GEN 1:1 Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.
GEN 1:2 Di eart nor get shape at-all. E dey empty and darkness kover di wota, but God Spirit dey waka on-top di wota.
GEN 1:3 So God kon sey, “Make lite kom.” And lite kon kom!
GEN 1:4 God si sey di lite dey good, so E kon separate di lite from di darkness.
GEN 1:5 God koll di lite, “Day” and di darkness, E koll am, “Nite.” And dat evening and morning kon make am di first day.
GEN 1:6 God sey, “Make di wota divide into two, so dat space go dey di middle.”
GEN 1:7 So God separate di wota wey dey under di space from di wota wey dey on-top di space. And na so e kon bi.
GEN 1:8 God koll di space, “Sky.” And dat evening and morning kon make am di sekond day.
GEN 1:9 God sey, “Make di wota wey dey under di sky gada for one place and make dry groun kom out.” And na so e kon bi.
GEN 1:10 God kon koll di dry groun, “Land” and di wota wey gada, E koll am, “Sea.” God si sey e dey good.
GEN 1:11 God kon sey, “Make di land produce difren plants: plants wey go bear seeds akordin to how dem bi and trees wey go bear fruit akordin to how dem bi.” And na so e kon bi.
GEN 1:12 Di land produce difren plants; di ones wey dey bear seeds and fruits, akordin to dia kind. God kon si sey e dey good.
GEN 1:13 So dat evening and morning kon make am di third day.
GEN 1:14 God sey, “Make lite dey for di sky wey go separate di day from di nite and make sign dey wey go show sizin, days, years
GEN 1:15 and make dem bi lite for di sky wey go give lite to di eart.” And na so e kon bi.
GEN 1:16 God make two big lite: di one wey big pass go shine for day time and di small one go shine for nite. God make di stars too.
GEN 1:17 God put di lite for di sky, so dat e go dey shine for di eart
GEN 1:18 and dem go dey rule both for day and nite. Dem go separate lite from darkness. So God si sey evritin dey good.
GEN 1:19 And dat evening and morning kon make am di fourt day.
GEN 1:20 Den God kon sey, “Make difren animals wey get life full di wota and make birds full di sky.”
GEN 1:21 God kreate di big-big fish for sea and evry oda tin wey dey stay inside wota and difren-difren birds. God si sey dem dey good.
GEN 1:22 God bless dem kon sey, “Make una stay di wota kon born many shidren and make di birds born many pikin full di sky.”
GEN 1:23 So dat evening and morning kon make am di fift day.
GEN 1:24 Den God sey, “Make di land produce difren animals akordin to dia kind: kattle, tins wey dey creep for groun and wild animals akordin to dia kind.” And na so e kon bi.
GEN 1:25 God make wild animals, kattle and evritin wey dey creep for groun akordin to dia kind. God kon si sey dem dey good.
GEN 1:26 Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”
GEN 1:27 So God kon kreate human being like ensef; as God bi, na so E kreate dem; both man and woman, na-im E kreate.
GEN 1:28 God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
GEN 1:29 Den God sey, “Evry plant wey dey bear seed and tree wey dey bear fruit, I give dem to una as food.
GEN 1:30 Plus all di animals for di eart; birds for di sky and evritin wey dey waka for groun. Evritin wey dey alive and evry green plant, I gi-am to una as food.” And na so e kon bi.
GEN 1:31 So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.
GEN 2:1 God kon kreate evritin wey dey di heaven and di eart finish.
GEN 2:2 For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.
GEN 2:3 God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
GEN 2:4 Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.
GEN 2:5 For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put.
GEN 2:6 But wota dey flow from di sea kon wet di groun.
GEN 2:7 So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
GEN 2:8 God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.
GEN 2:9 God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
GEN 2:10 So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river.
GEN 2:11 Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
GEN 2:12 (Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.)
GEN 2:13 Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land.
GEN 2:14 Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
GEN 2:15 God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin.
GEN 2:16 Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin,
GEN 2:17 but make yu nor chop from di tree wey get life; wey dey make pesin know tins; di tree wey dey good and bad, bikos wen ever yu chop from am, na dat day, yu go die.”
GEN 2:18 Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
GEN 2:19 God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
GEN 2:20 So man name all di animals, birds for di sky and evritin wey get life for di eart, but Adam nor si anytin wey bi like am.
GEN 2:21 So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place.
GEN 2:22 Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
GEN 2:23 Den di man sey, “At last, dis one bone kom from my bone and en flesh kom from my flesh; I go koll am, ‘Woman,’ bikos God make am from man.”
GEN 2:24 Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
GEN 2:25 Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.
GEN 3:1 Na snake play wayo pass any wiked animal wey God kreate. So di snake tell di woman, “Na true sey God sey, ‘Make una nor chop from all di tree wey dey di gardin’?”
GEN 3:2 Di woman ansa, “No o-o! Wi fit chop from all di fruit wey dey di gardin;
GEN 3:3 but about di fruit from di tree wey dey di gardin centre, God sey, ‘Una must nor chop or tosh am, bikos if una chop or tosh am, una go die.’ ”
GEN 3:4 So, di snake tell di woman, “True-true, una nor go die,
GEN 3:5 bikos God know sey wen una chop from di tree, una eyes go open and una go bi like God ensef, wey know wetin dey good or bad.”
GEN 3:6 Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
GEN 3:7 Den dem two eye kon open and dem kon know sey dem nor wear anytin; so dem sew fig leaf togeda kon take am kover dia body.
GEN 3:8 Den di man and en wife kon dey hear Oga God dey waka for di gardin wen evriwhere don kwayet for evening, so dem kon hide from di Oga wey bi dia God.
GEN 3:9 But God koll di man kon sey, “Where yu dey?”
GEN 3:10 Di man ansa, “I hear wen Yu dey waka for di gardin and fear kon katch mi, bikos I nor wear anytin, so I kon hide.”
GEN 3:11 So Oga God ask am, “Na who tell yu sey yu dey naked? Abi, yu don chop di fruit for di tree wey I sey make yu nor chop?”
GEN 3:12 Di man ansa, “Di woman wey Yu give mi bring some fruits from di tree and I kon chop am.”
GEN 3:13 Den Oga God tell di woman. “Wetin bi dis wey yu don do so?” Di woman ansa, “Di snake deceive mi and I kon chop from am.”
GEN 3:14 God kon tell di snake, “Bikos yu do like dis, “For all di wild animals wey I kreate for dis eart, curse dey yor head! Na belle yu go take dey waka and na san-san yu go dey chop for all yor life.
GEN 3:15 I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”
GEN 3:16 God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”
GEN 3:17 God tell Adam, “Yu obey yor wife kon chop from di tree wey I kommand yu sey, ‘Make yu nor chop from.’ “Bikos yu do dis, I curse di groun. Yu go work hard to make di groun bring food till yu die.
GEN 3:18 E go dey bring out grass for yu, but na di korn from di groun na-im yu nid as food.
GEN 3:19 Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”
GEN 3:20 Di man kon koll en wife Eve, bikos na en bi mama to evritin wey dey alive.
GEN 3:21 God use skin take make garment for Adam and en wife kon give dem make dem wear.
GEN 3:22 So God sey, “Naw wen man don bi like us, wen e don know wetin dey good and bad, make wi nor let am chop from di tree wey dey give life, if not, e nor go ever die.”
GEN 3:23 So Oga God kon porshu man and en wife komot from Eden Gardin, so dat e go-go farm for di groun where God from kreate am.
GEN 3:24 Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.
GEN 4:1 Adam sleep with Eve en wife and e get belle kon born boy, den e sey, “I don get boy just as di Oga God wont!” So e koll am, “Kain.”
GEN 4:2 Eve get belle again kon born anoda boy and en name na Abel. Abel dey kare for di animals, while Kain na farmer.
GEN 4:3 Afta sometaim, Kain kon bring some fruit from di groun wey e won offa give Oga God.
GEN 4:4 While Abel bring some of di first-born for en animals wey fat pass. God like wetin Abel bring,
GEN 4:5 but E nor like Kain and en ofrin. So Kain kon dey vex and e face kon shange.
GEN 4:6 Den Oga God ask Kain, Wetin make yu dey vex and why yor face shange?
GEN 4:7 “Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”
GEN 4:8 Kain kon tell en broda Abel sey, “Make wi go di field.” As dem dey di field, Kain rush en broda Abel kon kill-am.
GEN 4:9 Den Oga God ask Kain, “Where yor broda dey?” Kain ansa, “I nor know! Na mi dey keep my broda?”
GEN 4:10 But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi!
GEN 4:11 So naw, I go drive yu komot from di groun where yu for kill yor broda; di groun wey swallow yor broda blood from yor hand.
GEN 4:12 Wen ever yu try to plant seed for di groun, e nor go grow well for yu. Yu go dey waka anyhow for dis eart without house.”
GEN 4:13 Den Kain tell di Oga God, “Abeg! My ponishment too big for mi!
GEN 4:14 Si! Yu dey porshu mi from di land and I must hide make Yu nor si mi. I go dey waka without house for dis eart; so anybody wey si mi, go kill mi.”
GEN 4:15 But di Oga God kon sey, “Okay, if anybody kill Kain, seven pesin go die too from en family.” Den di Oga God kon put one special mark for en head, so dat anybody wey si am, nor go kill-am.
GEN 4:16 So Kain komot from di Oga God front kon go stay Nod land wey dey di east side for Eden.
GEN 4:17 Kain sleep with en wife and e get belle kon born boy wey e koll Enoch. Kain build one town kon name am, Enoch wey bi en pikin name.
GEN 4:18 Enoch kon born Irad and na Irad bi Mehujael papa. Mehujael born Metushael and na Metushael bi Lamek papa.
GEN 4:19 Lamek marry two wife; di first one name na Adah and di sekond one na Zillah.
GEN 4:20 Adah kon born Jabal and e dey among doz wey first stay inside tent and get animals.
GEN 4:21 En broda name na Jubal and e dey among doz wey first play di harp and flute.
GEN 4:22 Naw, Zillah still born Tubal-Kain wey dey melt iron, make difren tools: swod, knife both from bronze and iron. Tubal-Kain sista name na Naamah.
GEN 4:23 Lamek kon tell en wifes: “Adah and Zillah! Make una listin to mi! Una wey bi Lamek wife, make una hear wetin I won tok! I don kill pesin, bikos e wound mi; I kill di yong man, bikos e make mi vex.
GEN 4:24 If seven pipol go die bikos dem kill Kain, den seventy-seven pipol go die for Lamek.”
GEN 4:25 Adam sleep with en wife again and e get belle kon born boy, den Eve koll am Seth, bikos e sey, “God don give mi anoda pikin wey go take Abel place. Abel wey Kain kill.”
GEN 4:26 Seth too kon born boy and en name na Enosh. From dat time, pipol kon start to woship Oga God.
GEN 5:1 Dis na di rekord of Adam family. Wen God kreate human being, E make dem just as E bi.
GEN 5:2 Na both man and woman E kreate kon bless and koll dem, “Human being.”
GEN 5:3 Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.
GEN 5:4 Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.
GEN 5:5 Di total days wey Adam live, na nine hundred and thirty years and e kon die.
GEN 5:6 Wen Seth don stay for one hundred and five years, e kon born Enosh.
GEN 5:7 Seth dey for eight hundred and seven years again and e born some oda sons and dotas.
GEN 5:8 Di total life wey Seth live na nine hundred and twelf years and e kon die.
GEN 5:9 Wen Enosh don stay for ninty years, e kon born Kenan.
GEN 5:10 Enosh stay for eight hundred and fifteen years afta e don born Kenan and e born oda shidren.
GEN 5:11 Di total life wey Enosh live na nine hundred and five years, den e kon die.
GEN 5:12 Wen Kenan don live for seventy years, e kon born Mahalalel.
GEN 5:13 Kenan live for eight hundred and forty years afta e born Mahalalel and e born oda shidren.
GEN 5:14 Di total life wey Kenan live na nine hundred and ten years and e kon die.
GEN 5:15 Wen Mahalalel don live for sixty-five years, e kon born Jared.
GEN 5:16 Mahalalel stay for anoda eight hundred and thirty years afta e born Jared and e born oda shidren.
GEN 5:17 Di total life wey Mahalalel live na nine hundred and ninty-five years and e kon die.
GEN 5:18 Wen Jared don live for one hundred and sixty-two years, e kon born Enoch.
GEN 5:19 Jared live for anoda eight hundred years and e get oda sons and dotas.
GEN 5:20 Di total life wey Jared live na nine hundred and sixty-two years and e kon die.
GEN 5:21 Wen Enoch don live for sixty-five years, e kon born Metuselah.
GEN 5:22 Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.
GEN 5:23 Di total life wey Enoch live na three hundred and sixty-five years.
GEN 5:24 Enoch waka with God, den e vanish, bikos God take am.
GEN 5:25 Wen Metuselah don live for one hundred and eighty-seven years, e kon born Lamek.
GEN 5:26 Metuselah live anoda 700 and eighty-two years afta e born Lamek, en brodas and sistas.
GEN 5:27 Di total life wey Metuselah live na nine hundred and sixty-nine years, den e kon die.
GEN 5:28 Wen Lamek don live for one hundred and eight two years, e kon born boy.
GEN 5:29 E koll di boy Noah kon sey, “Dis one go give us rest from all di hard-hard work wey wi dey do from dis groun wey Oga God don curse.”
GEN 5:30 Lamek live for five hundred and ninty five year afta e born Noah and e still get oda shidren.
GEN 5:31 Di total life wey Lamek live na seven hundred and seventy-seven years and e kon die.
GEN 5:32 Afta Noah don stay for five hundred years, e kon born Shem, Ham and Jafet.
GEN 6:1 Wen human being don plenty for di world and dem kon dey born girls,
GEN 6:2 some among God sons kon si as woman fine rish. So dem kon dey marry dem as wife.
GEN 6:3 So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.”
GEN 6:4 Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.
GEN 6:5 But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.
GEN 6:6 Oga God regret sey E make human being for dis eart and E kon dey vex.
GEN 6:7 So Oga God sey, “I go distroy human being wey I kreate komot for dis eart; plus evritin, from human being go rish animals, join di ones wey dey creep for groun and di birds for di sky, bikos I dey vex sey I kreate dem.”
GEN 6:8 But di Oga God like Noah well-well, bikos e dey good for God eye.
GEN 6:9 Dis na Noah story. Noah na pesin wey dey fear God; e nor get fault for body among evry oda human being. E dey waka with di Oga God.
GEN 6:10 Noah get three boys and dia name na: Shem, Ham and Jafet.
GEN 6:11 But evry oda pesin dey bad for di Oga God eye.
GEN 6:12 God look di eart kon si sey e dey bad well-well, bikos all di pipol dey live wiked life.
GEN 6:13 So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.
GEN 6:14 “Make yu go make one boat kon kover am for inside and outside.
GEN 6:15 Dis na how yu go make am: Di boat go long rish 400 fit, e go wide rish seventy-five fit and e go high rish forty-five fit.
GEN 6:16 Yu go make roof for di boat, finish am kon leave space wey rish eight inches from di top. Put one door for di boat and yu go divide am into three: di lowa one, di middle and di uppa one.
GEN 6:17 “I go make rain fall for di eart wey go distroy evritin wey get life under di sky. Evritin wey dey di eart go die,
GEN 6:18 but I go keep my kovenant with yu. Yu go enter di boat: yu, yor sons, yor wife and yor shidren dem wife.
GEN 6:19 Yu must take two-two of evry kind animals enter di boat, make dem bi man and woman, so dat dem go fit born and dey alive with yu.
GEN 6:20 For evry kind bird, yu go take two and for evry kind kattle, doz animal wey dey creep for groun, yu go take two-two, so dat yu go keep dem.
GEN 6:21 And yu go take and gada evry kind food enter inside di boat, so dat una go dey si food chop.”
GEN 6:22 So Noah do as God kommand am.
GEN 7:1 So Oga God tell Noah, “Make una enter di boat, yu and yor family, bikos I si sey yu nor get fault among evribody for dis yor generashon.
GEN 7:2 Yu must karry seven man and seven woman for evry klean animal follow body, but for evry animal wey nor dey klean, yu go take only one man and one woman.
GEN 7:3 Den yu go still take seven man and seven woman from evry kind bird wey dey fly for sky, so dat dem go born many shidren leta.
GEN 7:4 Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”
GEN 7:5 So Noah do as God kommand am.
GEN 7:6 Noah don rish six hundred years wen wota kover di eart.
GEN 7:7 Noah enter di boat with en sons, en wife and en shidren wife dem wen di rain won fall.
GEN 7:8 Two-two from evry klean animal; animals wey nor klean; birds and evritin wey dey creep for groun,
GEN 7:9 both man and woman, all enter di boat kom meet Noah, just as God kommand am.
GEN 7:10 And afta seven days, di rain kon start to fall.
GEN 7:11 Wen Noah don old rish six hundred and two monts, for di seventint day for di mont, all di wota for sky bigin rush anyhow and di heaven kon open,
GEN 7:12 den rain from heaven kon start to fall for di eart for forty days and forty nites.
GEN 7:13 For dat very day, Noah enter di boat with en sons Shem, Ham and Jafet, plus en wife and en shidren wife.
GEN 7:14 Dem enter with evry kind tin wey get life; difren animal; evritin wey dey creep for groun akordin to how dem bi and evry bird akordin to how dem bi, plus evritin wey get feada.
GEN 7:15 Two-two from evritin wey get life kom meet Noah inside di boat.
GEN 7:16 Doz wey enter na man and woman, just as God kommand am. Den Oga God klose di boat door.
GEN 7:17 Di wota fall for di eart for forty days. As di wota dey many, di boat dey go up.
GEN 7:18 Di wota kover di eart and di boat kon dey float on-top di wota.
GEN 7:19 Di wota kon kover di eart sotey e even kover di mountins wey high pass for di eart.
GEN 7:20 Di wota kon high rish twenty fit afta e don kover di mountins wey high pass.
GEN 7:21 And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being.
GEN 7:22 Evritin for land wey dey breath thru dia nose kon die.
GEN 7:23 So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.
GEN 7:24 Di wota kover di eart for one hundred and fifty days.
GEN 8:1 But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.
GEN 8:2 Di rivers for heaven klose and di rain kon stop to fall from di sky.
GEN 8:3 Di wota kon dey dry small-small, so afta one hundred and fifty days, dry groun kon show.
GEN 8:4 For di seventint day for di seven mont, di boat kon stay on-top one mountin wey dem dey koll Ararat.
GEN 8:5 Di wota still dey go down until di tent mont and dem kon dey si top of di mountin.
GEN 8:6 Afta forty days, Noah open di window wey e make for di boat
GEN 8:7 kon send one bird go; di bird fly dey go front and back, until di wota kon dry finish.
GEN 8:8 Den Noah send anoda bird make e go si if di wota don dry finish.
GEN 8:9 Di dove nor si anywhere pesh put, bikos wota still kover di eart, so e kom meet Noah back for di boat.
GEN 8:10 Noah wait for anoda seven days, den e send di dove go again.
GEN 8:11 Wen di dove kom back for evening, betta fresh olive tree leaf dey en mout! Noah kon know sey di wota don almost dry finish.
GEN 8:12 E wait for anoda seven days, den e send di dove go again, but dis time, di dove nor kom back.
GEN 8:13 Wen Noah don rish six hundred and one year, for di first day for di first mont, di wota kon dry finish from di eart and Noah open di boat kon si sey di groun don dry.
GEN 8:14 So for di twenty-seven day for di sekond mont, di eart kon dry finish.
GEN 8:15 Den God tell Noah,
GEN 8:16 “Make una kom out from di boat, both yu, yor wife, yor shidren and dia wife.
GEN 8:17 Make all di tins wey get life kom out with yu. Make evritin kom out: di birds, animals and evritin wey dey creep for groun. Make dem get belle kon born full di eart!”
GEN 8:18 Noah kom out with en sons, wife and en pikin wife dem.
GEN 8:19 Evritin wey get life: animals, birds and di ones wey dey creep kon kom out one-by-one.
GEN 8:20 Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar.
GEN 8:21 Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.
GEN 8:22 “As long as di eart dey, time go dey to plant and time go dey to plok wetin dem plant. Sometaims kold go dey and oda times heat go dey. Rain go fall sometaims and oda times evriwhere go dry, but day and nite go always dey.”
GEN 9:1 Den God bless Noah and en shidren kon tell dem, “Make una born full di eart.
GEN 9:2 Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa.
GEN 9:3 Una fit chop anytin wey still dey waka. As I give una di green plant, na so too I don give una evritin.
GEN 9:4 But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am.
GEN 9:5 If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.
GEN 9:6 “Na as God bi, dem make man, so anybody wey kill pesin, na so too anoda pesin go kill-am.
GEN 9:7 But yu go get many shidren and dem go many kon full di whole eart.”
GEN 9:8 God kon tell Noah and en sons sey,
GEN 9:9 “Si! I dey make my kovenant with yu and yor shidren-shidren
GEN 9:10 and with evritin wey dey alive: all di birds and animals, evritin wey follow yu kom out from di boat.
GEN 9:11 Na with dis word I take enter kovenant with yu; I promise sey I nor go ever distroy di eart with wota again.”
GEN 9:12 And God sey, “Dis na di sign for di kovenant wey I dey make with yu and evritin wey get life and dis kovenant na from one generashon go rish anoda:
GEN 9:13 I go use rainbow as sign for di sky and e go bi sign for di kovenant wey I make with di eart.
GEN 9:14 Wen ever I bring kloud make e kover di eart and di rainbow sign appear for di sky,
GEN 9:15 den I go remember di kovenant wey I make with una and evritin wey get life akordin to how dem bi. Wota nor go ever kom distroy di eart and evritin wey get life again.
GEN 9:16 Wen di rainbow dey for di kloud, I go si am kon remember di everlastin kovenant between mi and evritin wey get life for dis eart.”
GEN 9:17 So God tell Noah, “Dis na sign for di kovenant wey I make between mi and evritin wey get life for dis eart.”
GEN 9:18 Noah sons wey kom out from di boat na Shem, Ham and Jafet. (Na Ham bi Kanaan pipol papa.)
GEN 9:19 Dis na Noah sons and from dem, pipol kon full di whole eart.
GEN 9:20 Noah wey bi farmer na-im bi di first man to plant vineyard.
GEN 9:21 Wen e drink some for di wine, di drink kon katch am and e naked for inside di tent.
GEN 9:22 Ham wey bi Kanaan papa kon si sey en papa dey naked and e kon tell en two brodas wey dey outside.
GEN 9:23 Shem and Jafet take di klot kon put am for dia shoulder. Den dem kon take back waka enter kon kover dia papa nakednes.
GEN 9:24 Wen Noah wake-up from en sleep, e kon si wetin e sons do to am.
GEN 9:25 So e sey, “I curse Kanaan! Na en go bi slave to en brodas.”
GEN 9:26 E still sey, “Make wi praiz God wey bi Shem God and Kanaan go bi en savant.
GEN 9:27 Anytin wey Jafet put en hand, God go make am betta! Make e stay Shem tent and Kanaan go bi en savant!”
GEN 9:28 Afta di rain, Noah stay for three hundred and fifty years.
GEN 9:29 Di total life wey Noah stay na nine hundred and fifty years, den e kon die.
GEN 10:1 Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.
GEN 10:2 Jafet shidren na Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.
GEN 10:3 Gomer kon born Ashkenaz, Rifat and Togarmah.
GEN 10:4 Javan shidren na Elisha, Tarshish (wey bi Spain naw), Kittim pipol dem (wey bi Cyprus naw) and Dodanim pipol (wey bi Rhodes naw.)
GEN 10:5 Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.
GEN 10:6 Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
GEN 10:7 Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.
GEN 10:8 Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
GEN 10:9 En na strong hunta for Oga God front. Dat na why dem dey sey, “Just like Nimrod wey bi strong hunta for God present.”
GEN 10:10 For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.
GEN 10:11 From dat land, e kon go Assyria where e for build Nineveh, Rehobot, Kalah
GEN 10:12 and Resen where dey di centre for Nineveh and di great town wey bi Kalah.
GEN 10:13 Mizraim (wey bi Egypt naw) shidren na Lud pipol (wey bi Lydia naw), Anam, Lehab, Naftuh,
GEN 10:14 Patrus, Kasluh (na from dem Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol.
GEN 10:15 Kanaan shidren na Sidon wey bi en first pikin, Het,
GEN 10:16 Jebus, Amor, Girgash,
GEN 10:17 Hiv, Ark, Sin,
GEN 10:18 Arvad, Zemar and Hamat pipol. Leta, Kanaan family kon skata
GEN 10:19 and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.
GEN 10:20 Dis na Ham shidren akordin to dia family, dia language, lands and kountries.
GEN 10:21 Dem still born some sons give Shem (wey bi Jafet senior broda) and na Shem bi papa to all Eber sons.
GEN 10:22 Shem shidren na Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Mash.
GEN 10:23 Aram shidren na Uz, Hul, Geta and Mash.
GEN 10:24 Arfaxad na Shelah papa and Shelah na Eber papa.
GEN 10:25 Eber get two sons: One name na Peleg, bikos na en time dem take divide di eart and en broda name na Joktan.
GEN 10:26 Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,
GEN 10:27 Hadoram, Uzal, Diklah,
GEN 10:28 Obal, Abimael, Sheba,
GEN 10:29 Ofir, Havilah and Jobab dem na Joktan sons.
GEN 10:30 Where dem dey stay na from Mesha go rish Sefar for di hill for east.
GEN 10:31 Dis na Shem sons akordin to dia family, language, lands and kountry.
GEN 10:32 Dis na Noah family akordin to dia generashon, kountry and dia pipol kon full di eart afta di rain don fall finish.
GEN 11:1 From di biginnin wen di world start, evribody dey speak only one language.
GEN 11:2 As dem skata go di east side dem kon rish one place wey dem dey koll Shinar kon stay for der.
GEN 11:3 Den dem tell each oda sey, “Make wi do stone kon bake dem make dem for strong well-well.” So dem do strong stone wey dem go take build.
GEN 11:4 Den dem sey, “Naw, make wi build one town wey go high rish di sky, so dat wi go make name for awasef, if not, wi go skata for evriwhere for di eart.”
GEN 11:5 Den Oga God kom down kon si di town wey doz men dey build,
GEN 11:6 so E kon sey, “If dem dey do dis as pipol wey dey speak one language, den nor-tin go stop dem for anytin wey dem won do. E nor go tey before, dem go fit do anytin wey dem wont!
GEN 11:7 So make wi go down go skata dem kon mix dia language, so dat dem nor go undastand each oda.”
GEN 11:8 So di Oga God skata dem for evriwhere for di eart and dem kon stop to build di town.
GEN 11:9 Dat na why dem koll di town, Babel, bikos God give dem difren language and from der, E skata dem for evriwhere for di world.
GEN 11:10 Dis na Shem shidren. Two years afta di rain, wen Shem don rish hundred years, e kon born Arfaxad.
GEN 11:11 Afta e born Arfaxad, Shem stay for five hundred years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:12 Wen Arfaxad na thirty-five years, e kon born Shelah.
GEN 11:13 Afta Arfaxad don born Shelah, e stay for 400 and three years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:14 Wen Shelah na thirty years, e born Eber.
GEN 11:15 Afta e born Eber, Shelah stay for 400 and three years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:16 Wen Eber na thirty-four years, e born Peleg.
GEN 11:17 Afta e born Peleg, Eber stay for four hundred and thirty years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:18 Wen Peleg na thirty years, e kon born Reu.
GEN 11:19 Afta e born Reu, Peleg stay for two hundred and nine years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:20 Wen Reu na thirty-two years, e kon born Serug.
GEN 11:21 Afta e born Serug, Reu stay for two hundred and seven years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:22 Wen Serug na thirty years, e kon born Nahor.
GEN 11:23 Afta e born Nahor, Serug stay for two hundred years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:24 Wen Nahor na twenty-nine years, e kon born Terah.
GEN 11:25 Afta e born Terah, Nahor stay for one hundred and nineteen years and e born oda sons and dotas.
GEN 11:26 Wen Terah na seventy years, e kon born Abram, Nahor and Haran.
GEN 11:27 Dis na Terah shidren-shidren. Terah born Abram, Nahor and Haran. And na Haran bi Lot papa.
GEN 11:28 Haran die for di land wey dem for born am, inside Ur for Kaldea, wen en papa Terah still dey alive.
GEN 11:29 Abram and Nahor kon marry wife. Abram wife name na Sarai and Nahor wife name na Milka wey bi Haran pikin and Haran na still Iskah papa too.
GEN 11:30 But Sarai nor fit get belle; so e nor get pikin.
GEN 11:31 Terah kon karry en pikin Abram, en grand-pikin Lot and en pikin wife Sarai, dey follow body go Ur for Kaldea, so dat dem go-go Kanaan. Wen dem rish Haran, dem kon stay for der.
GEN 11:32 Di total life wey Terah live na two hundred and five years, den e kon die for Haran.
GEN 12:1 Naw, God kon tell Abram sey, “Komot from yor kountry; leave yor relashon and yor papa house kon go di land wey I go show yu.
GEN 12:2 “Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.
GEN 12:3 I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.”
GEN 12:4 So Abram kon go, just as God tell am sey make e do and Lot follow am go too. (Naw, Abram na seventy-five years wen e komot from Haran.)
GEN 12:5 Abram take en wife Sarai, en broda pikin Lot and evritin wey e get, plus di pipol wey dey with dem for Haran and all of dem kon go Kanaan land.
GEN 12:6 Abram travel pass Moreh oak tree for Shekem. (For dat time, Kanaan pipol dey stay for di land.)
GEN 12:7 God appear to Abram kon sey, “I go give dis land to yor shidren-shidren.” So Abram build one altar to God wey appear to am for der.
GEN 12:8 Den e komot from der go di hill kountry for Bethel for east kon stay der. E build anoda altar for der for God kon woship am.
GEN 12:9 Abram kon dey travel small-small until e rish Negev.
GEN 12:10 But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well.
GEN 12:11 As e near Egypt, e kon tell en wife Sarai sey, “Si o-o, I know sey yu bi fine woman
GEN 12:12 and wen Egypt men go si yu, dem go sey, ‘Dis na en wife.’ Den dem go kill mi bikos of yu.
GEN 12:13 So make yu tell dem sey, yu bi my sista, so dat dem nor go kill mi.”
GEN 12:14 Wen Abram enter Egypt, Egypt pipol si as di woman fine well-well.
GEN 12:15 Wen Fero offisa si di woman, dem kon tell Fero about am
GEN 12:16 and e trit Abram well, bikos of di woman. Abram kon kollect sheep and kattle, both man donkey and kamel.
GEN 12:17 But God kon send one bad diziz enter Fero house, bikos of Sarai, Abram wife.
GEN 12:18 So Fero koll Abram kon sey, “Wetin bi dis wey yu don do so? Why yu nor tell mi sey dis woman na yor wife?
GEN 12:19 Wetin make yu sey, ‘Di woman na my sista?’ Naw, I don take am as my wife! Make yu take di woman and make una komot for here!”
GEN 12:20 So Fero kon orda en offisa make dem porshu Abram, en wife and evritin wey bi dia own, komot from di town.
GEN 13:1 So Abram komot from Egypt kon go Negev. E take en wife, Lot and evritin wey e get follow body.
GEN 13:2 (Naw, Abram get many animals, silva and gold.)
GEN 13:3 E dey travel from one place go anoda, from Negev go rish Bethel. Den e kom back to di place wey dey between Bethel and Ai, where e for first put en tent.
GEN 13:4 Dis na di place where e for first build altar. So Abram kon woship God for der.
GEN 13:5 Lot wey dey travel with Abram, still get animals and propaty too.
GEN 13:6 So di land nor big rish for di two of dem, bikos dem dey togeda and dia animals too many.
GEN 13:7 So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.)
GEN 13:8 Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas.
GEN 13:9 So make wi separate. Choose any part for di land wey yu wont. Make yu go one side, while I go-go di oda side.”
GEN 13:10 Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.)
GEN 13:11 So Lot choose di whole River Valley for ensef kon waka go di east side. Dis na how Abram and Lot take separate.
GEN 13:12 Abram stay for Kanaan and Lot kon stay for di town wey dey di valley and e kamp near Sodom
GEN 13:13 wey en pipol wiked and dey sin against God.
GEN 13:14 Afta Lot don go, God kon tell Abram sey, “Make yu look from di place where yu stand to di nort, sout, east and west.
GEN 13:15 All di land wey yu dey si so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren forever.
GEN 13:16 And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem.
GEN 13:17 So make yu get up go look di land dem, bikos I go gi-am to yu.”
GEN 13:18 So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.
GEN 14:1 For dat time, Amrafel wey bi Shinar king, Ariok wey bi Ellasar king with Kedorlaoma wey bi Elam king and Tidal wey bi Goyim king
GEN 14:2 kon gada go fight, Bera wey bi Sodom king, Birsha wey bi Gomorrah king, Shinab wey bi Admah king, Shemeba wey bi Zeboiim king and Bela king (di place wey dem also dey koll Zoar).
GEN 14:3 Dis five kings join togeda for Siddim Valley (wey bi Salt Sea).
GEN 14:4 For twelf years, dem dey serve Kedorlaoma, but for di thirtint year dem kon fight against am.
GEN 14:5 For di fourteent year, Kedorlaoma and di kings wey join togeda kon go win Refah pipol for Ashterot-Karnaim, Zuz pipol for Ham, Emite pipol for Shaveh Kiriataim
GEN 14:6 and Horite pipol for dia hill kountry wey stay Seir go rish El-Paran wey dey near di wildaness.
GEN 14:7 Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.
GEN 14:8 Den Sodom, Gomorrah, Admah, Zeboiim and Bela (wey bi Zoar) kings kon ready for war. Dem meet each oda for Siddim Valley with
GEN 14:9 Elam king, Ariok king, Amrafel king and Tidal wey bi king for some oda kountries. So na four kings dey go fight against five.
GEN 14:10 Naw, Siddim Valley get some portor-portor. Wen Sodom and Gomorrah king dey run, some for en men kon fall enter di pit, while di rest, run go di hills.
GEN 14:11 Di four kings wey win di war, kollect all di propaty and food wey Sodom and Gomorrah get, den dem kon go.
GEN 14:12 Dem still karry Abram broda pikin, Lot and en propaty follow body, bikos Lot dey stay for Sodom.
GEN 14:13 One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)
GEN 14:14 Wen Abram hear sey dem dey karry en broda pikin go as slave, e kon koll en three hundred and eighteen men wey dem train well and dem born dis men for en house, den dem kon porshu di four kings go rish Dan.
GEN 14:15 So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus.
GEN 14:16 E kollect evritin wey dem tif. E still bring en broda pikin, Lot and en propaty with all di wimen and evribody kom back.
GEN 14:17 Afta Abram don beat Kedorlaoma and di kings wey dey with am, Sodom king kon go meet Abram for Shaveh Valley (wey dem dey koll Kings Valley).
GEN 14:18 Melkizedek wey bi Salem king kon bring wine and bread kom out. (Dis Melkizedek na di Most High God priest.)
GEN 14:19 E bless Abram kon sey, “Make di Most High God bless Abram, di God wey kreate heaven and eart.
GEN 14:20 Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.
GEN 14:21 Den Sodom king kon tell Abram sey, “Abeg give mi di pipol, make yu take evry oda tin.”
GEN 14:22 But Abram ansa, “I raiz my hand to di Oga God, di Most High God wey kreate heaven and eart and I promise
GEN 14:23 sey I nor go take anytin wey bi yor own. Nor bi even yor rope or sandal. So dat yu nor go sey, ‘Na mi make Abram get money.’
GEN 14:24 I nor go take anytin escept di food wey my men chop and di tins wey dem use. But make my men, Aner, Eshkol and Mamre take dia share.”
GEN 15:1 Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”
GEN 15:2 But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, wetin Yu go give mi, since I neva born pikin and na dis Elieza for Damaskus go inherit my propaty?”
GEN 15:3 Abram still sey, “Since Yu neva give mi shidren, den one of my savants go inherit my propaty!”
GEN 15:4 But God sey: “Yor savant nor go inherit yor propaty, but na yor own pikin wey go kom from yor blood.”
GEN 15:5 God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”
GEN 15:6 Abram bilive God and bikos of en strong faith, God kon koll am raitious man.
GEN 15:7 God tell am, “Na mi bi di Oga God wey bring yu kom from Ur for Kaldea, so dat I go give yu all dis land as yor own.”
GEN 15:8 But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, na wetin go bi di sign to show sey I go get all dis land?”
GEN 15:9 God ansa, “Make yu bring one melu, one goat and one ram; make all of dem bi three years, den take one dove and one yong pijin follow body.”
GEN 15:10 So Abram take all of dem go gi-am kon kut dem into two, den e put di two side face each oda, but e nor kut di birds.
GEN 15:11 Wen birds for sky won kon chop di tins wey Abram kill so, e kon porshu all of dem komot.
GEN 15:12 Wen nite rish, Abram kon sleep deep sleep, den fear kon dey katch am.
GEN 15:13 So God tell Abram sey, “Make yu know naw sey yor shidren go bi strenjas for anoda man land. Dem go ponish and trit dem like slave for four hundred years.
GEN 15:14 But I go judge di kountry wey go ponish dem. Afta evritin, dem go kom out with plenty propaty.
GEN 15:15 But for yu, wen yu don old well-well, yu go die with peace of mind kon go join yor grand-grand papa dem.
GEN 15:16 For di fourt generashon, yor shidren go kom back to dis place, bikos Amor pipol sin neva plenty rish.”
GEN 15:17 Wen evening rish and day don dark, one pot wey dey bring smoke with fire and dey shine like tosh kon pass between di animals wey Abram sakrifice.
GEN 15:18 Dat day, God kon make kovenant with Abram sey: “From Egypt borda go rish Eufrates River, I promise to give all dis land to yor shidren,
GEN 15:19 plus Kenite, Kenizz, Kadmon,
GEN 15:20 Hit, Periz, Refah,
GEN 15:21 Amor, Kanaan, Girgash and Jebus pipol land.”
GEN 16:1 Naw, Sarai wey bi Abram wife neva born any pikin, but e get one woman savant from Egypt, wey en name na Hagar.
GEN 16:2 So Sarai kon tell Abram, “Since God neva let mi born shidren, make yu sleep with my savant. May bi wi fit from der get awa own family.” Abram kon do as Sarai tok.
GEN 16:3 So Abram stay for Kanaan for ten years. Sarai wey bi Abram wife kon give Hagar wey bi en savant from Egypt to Abram as wife.
GEN 16:4 Abram sleep with Hagar and e kon get belle. As Hagar know sey e don get belle, e nor kon dey respet Sarai again.
GEN 16:5 Den Sarai kon tell Abram, “Na yu curse dis wahala for mi! I allow yu make yu sleep with my savant, but as e know sey e don get belle, e nor kom dey respet mi again. Make God judge between yu and mi!”
GEN 16:6 Abram ansa Sarai, “Since yor savant dey under yor pawa, make yu do am anytin wey yu like.” Den Sarai kon dey ponish Hagar, so Hagar kon run leave Sarai.
GEN 16:7 So God angel kon si Hagar near one wota for wildaness, di wota dey rush go Shur.
GEN 16:8 Di angel tell am, “Hagar, Sarai savant, where yu from kom and where yu dey go?” Hagar ansa, “I dey run from my madam, Sarai.”
GEN 16:9 Den di angel tell am, “Go back go meet yor madam make yu respet am.
GEN 16:10 I go make yor shidren-shidren great.” God angel still sey, “Dem go plenty well-well and nobody go fit kount dem.”
GEN 16:11 Den God angel tell Hagar, “Yu get belle naw and yu go soon born boy pikin. Yu go name am ‘Ishmael,’ bikos di Oga God don hear yor kry and si yor pains.
GEN 16:12 Yor pikin go live like donkey wey wiked well-well; e go dey against evribody and evribody go dey against am. E nor go stay with en family.”
GEN 16:13 Hagar kon ask ensef, “I don really si di God wey si mi?” So e koll di Oga God wey tok to am, “Di God Wey Dey Si.”
GEN 16:14 Dat na why pipol dey koll di well wey dey between Kadesh and Bered “Beer Lahai Roi” wey mean, “Di Well For Di God Wey Dey Alive And Dey Si Mi.”
GEN 16:15 So Hagar born boy for Abram and en name na Ishmael.
GEN 16:16 Dat time, Abram na eighty-six years.
GEN 17:1 Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
GEN 17:2 I go make my kovenant with yu kon give yu plenty shidren.”
GEN 17:3 Abram bow face groun and God tok to am,
GEN 17:4 “I make dis kovenant with yu: I promise sey yu go bi many pipol papa.
GEN 17:5 Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons.
GEN 17:6 I go give yu many shidren and some of dem go bi kings. Yu go get many shidren and dem go get kountries.
GEN 17:7 “I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
GEN 17:8 I go give yu and yor shidren dis land where yu dey stay as strenja naw. Di whole Kanaan land go bi yor shidren-shidren own forever and I go bi dia God.”
GEN 17:9 God still tell Abraham, “Yu too must gri sey yu go keep di promise wey yu make with mi, both yu and yor shidren-shidren.
GEN 17:10 Yu and yor shidren-shidren must agri to sekonsaiz evry boy pikin among una.
GEN 17:11 From naw go, yu must sekonsaiz evry pikin wey bi boy, eight days afta dem born am,
GEN 17:12 plus yor savant wey bi strenja shidren wey dem go born for here. Dis go show sey mi and yu, get kovenant.
GEN 17:13 Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever.
GEN 17:14 Anybody wey dem neva sekonsaiz, I nor go koll am my own, bikos e neva keep di kovenant with mi.”
GEN 17:15 God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah.
GEN 17:16 I go bless am and I go make am born boy for yu. I go bless am and Sarah go bi plenty pipol mama and kings go dey among en shidren-shidren.”
GEN 17:17 Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”
GEN 17:18 Abraham kon ask God, “Why Yu nor allow Ishmael to bi my only pikin?”
GEN 17:19 But God sey, “No! Yor wife Sarah go get belle kon born boy for yu and yu go koll am, Isaak. I go keep my kovenant with am and en shidren-shidren forever. Di kovenant na forever and ever.
GEN 17:20 I hear wetin yu tok about Ishmael. I go bless am kon gi-am many shidren. E go bi twelf prince papa and I go make en shidren-shidren great.
GEN 17:21 But I go keep my kovenant with yor pikin Isaak, wey Sarah go born for dis time next year.”
GEN 17:22 Wen God tok to Abraham finish, E kon leave am.
GEN 17:23 For dat same day, Abraham obey God kon sekonsaiz en pikin Ishmael and all di oda boys wey dey en house, plus en savants pikin and doz wey dey with am.
GEN 17:24 Abraham na ninty-nine years wen dem sekonsaiz am
GEN 17:25 and en son Ishmael na thirteen.
GEN 17:26 Na di same day dem take sekonsaiz Abraham, Ishmael
GEN 17:27 and all en savants.
GEN 18:1 God appear to Abraham near Mamre oak tree as e sidan for front of en house for one hot aftanoon.
GEN 18:2 Abraham look and e si three men stand for di oda side. Wen e si dem, e run go meet dem kon bow for dem.
GEN 18:3 E kon sey, “My oga, make una nor pass my house without sey una nor stop; I bi una savant.
GEN 18:4 Make I bring some wota kom make una take wosh leg; una fit rest for under di tree.
GEN 18:5 I go still bring some food kom make una chop, so dat una go get pawa to kontinue una journey. Una don respet mi to kom my house, so make I serve una.” Dem kon ansa, “Tank yu; wi gri.”
GEN 18:6 So Abraham rush enter house kon tell Sarah, “Make yu kwik-kwik measure some flower den bake bread.”
GEN 18:7 Den e run go where di animals dey, take one melu wey fine and fat kon give one savant, wey kwik-kwik go kill-am.
GEN 18:8 E take some cream, some milk and di meat kon set di food for di men front. For under di tree for der, Abraham kon serve dem by ensef and di men kon chop.
GEN 18:9 Den dem kon ask am, “Where yor wife Sarah?” Abraham ansa, “E dey inside house.”
GEN 18:10 One of dem kon sey, “Nine mont from naw, I go kom back and yor wife Sarah go born boy pikin.” Sarah dey di house back door dey listin.
GEN 18:11 Abraham and Sarah don old well-well and Sarah don stop to si en period.
GEN 18:12 So Sarah kon laf and tell ensef sey, “Naw wen I don old well-well so, I go fit still enjoy to born pikin? Even sef, my husband don old too.”
GEN 18:13 Den dem ask Abraham, “Wetin make Sarah dey laf kon sey, ‘I go fit really still born pikin wen I don old?’
GEN 18:14 E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”
GEN 18:15 Bikos Sarah dey fear, e kon deny sey, “Na lie! I nor laf.” But di Oga God kon sey, “No! Yu laf.”
GEN 18:16 Wen di men stand up won go, dem kon go where dem go for fit si Sodom well-well and Abraham escort dem go.
GEN 18:17 God kon tell Abraham, “I go tell yu wetin dey my mind.
GEN 18:18 Afta all, Abraham go bi plenty pipol papa and I go bless evribody thru am.
GEN 18:19 I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
GEN 18:20 Den God tell Abraham, “Di kry against Sodom and Gomorrah too mush and dia sins too many.
GEN 18:21 I must go der go si weda wetin I hear about dem, na true.”
GEN 18:22 Den di men leave Abraham kon waka dey go Sodom, but Abraham stay with Oga God.
GEN 18:23 Abraham go meet Oga God kon ask, “Yu won really distroy doz wey nor do bad with doz wey do bad?
GEN 18:24 Wot of if pipol wey dey fear Yu rish fifty for dat town? Yu go distroy di whole town? Yu nor go bikos of di fifty pipol leave di town?
GEN 18:25 I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”
GEN 18:26 God ansa, “If I si fifty pipol for Sodom wey dey fear mi, I go bikos of dem nor distroy di town.”
GEN 18:27 Den Abraham ask, “My Oga God! Abeg nor vex sey I too tok (even doh I just bi ordinary dust),
GEN 18:28 wot of if na five nor make am rish fifty? Yu go distroy di town, bikos five nor make am rish fifty?” Oga God ansa, “I nor go distroy di town if I si forty-five pipol for der wey dey fear mi.”
GEN 18:29 Abraham ask am again, “Wot if na forty?” God ansa, “I nor go distroy am, bikos of dat forty.”
GEN 18:30 Den Abraham sey, “God, make Yu nor vex o-o, bikos I still won tok! Wot of if dem bi thirty for der.” God ansa, “I nor go do am if I si thirty for der.”
GEN 18:31 Abraham kon sey, “Since I fit tok to Yu my Oga God, wot of if dem bi only twenty for der?” God ansa, “I nor go distroy di town bikos of dem.”
GEN 18:32 Abraham sey, “My Oga God! Abeg make Yu nor vex for yor savant. Wot of if dem bi ten wey dey fear Yu for di town?” God ansa, “I nor go distroy di town bikos of dat ten.”
GEN 18:33 Afta God tok to Abraham finish, God kon go leave am. Den Abraham go en house.
GEN 19:1 Di two angels kon rish Sodom for evening and dat time, Lot sidan for di town gate. Wen Lot si dem, e get up go meet dem kon bow face groun.
GEN 19:2 E kon sey, “Una my oga! Abeg, make una kom enter una savant house. Make una wosh una legs and na here una go sleep dis nite. Den tumoro morning, una fit kontinue una journey.” Di angels kon sey, “No! Wi go sleep for di town centre.”
GEN 19:3 Lot beg dem well-well, so dem kon enter en house. E kommand en savant make e bake bread without yist for dem and dem kon chop.
GEN 19:4 Before di angels go bed dat nite, Sodom men kon surround di house. All di men for di town, both yong and old gada for der.
GEN 19:5 Di men kon koll Lot dey sey, “Where di men wey kom meet yu dis evening? Bring dem kom out, so dat wi go sleep with dem!”
GEN 19:6 Lot go meet dem for outside kon klose di door.
GEN 19:7 E kon ansa, “No my brodas! Make una nor do dis wiked tin!
GEN 19:8 Si, I get two dotas wey neva sleep with man before. Make I give dem to una and una if do dem anytin wey una like. But make una nor do anytin to dis men, bikos na my house dem dey.”
GEN 19:9 Dem kon shaut gi-am sey, “Komot for awa front, yu wey bi strenja for dis place; na yu won tell us wetin wi go do! Wetin wi go do yu go worse pass wetin wi go do dem.”
GEN 19:10 But di angels inside Lot house open di door draw Lot enter inside kon klose am.
GEN 19:11 Di angel kon make di pipol eye blind; from di yong ones go rish di old ones. Den di men for outside kon dey find di door.
GEN 19:12 So di two angels kon tell Lot, “Yu still get anybody for dis town? Yor pikin husband dem dey di town? Abi yu get any broda or sista for here? Go tell dem make dem komot from dis town,
GEN 19:13 bikos wi kom distroy di town. Dia sin and di wiked tins wey dem dey do, don too many. So God send us kom distroy am.”
GEN 19:14 Den Lot go tell di men wey won marry en dotas sey, “Make una kwik-kwik komot from dis town, bikos God won distroy am!” But dem tink sey Lot dey lie for dem.
GEN 19:15 For morning, di angel kon tell Lot, “Make una dey go! Lot! Karry yor wife and shidren komot kwik-kwik, if not, wen God dey judge di town, dem go distroy una join!”
GEN 19:16 Wen Lot still dey slow, di angels kon drag en, en wife and en shidren komot di town, bikos God like Lot. Dem drop dem for outside di town.
GEN 19:17 Den one of di angels kon sey, “Make una run! Make nobody look back and make una nor stop for di valley until una rish di mountin, so dat nobody go die.”
GEN 19:18 But Lot ansa, “No! Abeg sir, nor let us run dat kind race.
GEN 19:19 Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road.
GEN 19:20 E get one small town for der and e nor too far. Abeg, make mi and my family run go der. If yu look, yu go know sey na small town and wi go dey save for der.”
GEN 19:21 Di angel kon sey, “Okay, I gri. I nor go distroy dat town.
GEN 19:22 So make una run go der, bikos I nor go fit do anytin until una rish der.” So na-im make dem dey koll di town Zoar, bikos Lot koll am, “small place”.
GEN 19:23 Sun just dey kom out wen Lot and en family rish Zoar.
GEN 19:24 Den God send sulfur and fire like rain kom Sodom and Gomorrah
GEN 19:25 kon distroy dem, plus di valley with all di pipol for der and evritin wey dey grow for di land.
GEN 19:26 But Lot wife look back and e kon turn to salt.
GEN 19:27 For di next morning, Abraham rush go di place where e for stand for God present before.
GEN 19:28 E look face Sodom and Gomorrah side and all di valley, but na only smoke e si wey dey kom out from der.
GEN 19:29 But wen God distroy di town and valley where Lot dey stay. E keep Abraham for en mind kon allow Lot run komot di town.
GEN 19:30 Bikos Lot dey fear to stay for Zoar, en and en dotas kon go di mountins go hide for one hole.
GEN 19:31 Di senior dota kon tell en sista, “Si! Awa papa don dey old and e nor get anybody for di whole world wey go marry and sleep with us, so dat wi go get shidren.
GEN 19:32 So, make wi give awa papa enough drink and wen e don high, wi go sleep with am, so dat wi go get belle kon born pikin thru am.”
GEN 19:33 So dat nite, dem kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di senior dota kon sleep with am.
GEN 19:34 Di next day, di senior dota kon tell en sista sey, “I sleep with papa yestiday nite; so make wi gi-am plenty drink today again, so dat yu go sleep with am.”
GEN 19:35 Dat nite, di girls kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di junior dota kon sleep with am.
GEN 19:36 Like dis, Lot kon give en dotas belle.
GEN 19:37 Di senior one born boy and e kon koll am Moab wey bi Moab pipol papa.
GEN 19:38 Di junior one born boy too and e kon koll am Ben-Ammi and na-im bi Ammon pipol papa.
GEN 20:1 Abraham travel from der go Negev aria kon stay between Kadesh and Shur. As Abraham bi strenja for Gerar,
GEN 20:2 e kon tell pipol sey Sarah na en sista. So Abimelek wey bi king for Gerar kon koll and take Sarah.
GEN 20:3 But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”
GEN 20:4 For dis time, Abimelek neva do anytin with Sarah and di king kon ansa God sey, “I neva do any bad tin! So Yu go just distroy mi and my pipol like dat?
GEN 20:5 But Abraham tell mi sey na en sista and even di woman still sey Abraham na en broda. All wetin I do na with betta mind and I neva do any bad tin.”
GEN 20:6 Den for di dream, God ansa am, “Yes, I know sey wetin yu do na with betta mind. Dat na di rizin wey make mi nor let yu sin against mi or tosh di woman.
GEN 20:7 Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”
GEN 20:8 So di next day for early morning, Abimelek kon koll all en savants. Wen e tell dem evritin wey happen, fear katch all of dem.
GEN 20:9 Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!”
GEN 20:10 Den di king ask Abraham, “Wetin make yu do like dis sef?”
GEN 20:11 Abraham ansa, “Bikos I feel sey nobody dey wey dey fear God for dis place and dem fit kill mi if I sey na my wife.
GEN 20:12 Sarah na really my sista, my papa pikin, but nor bi my mama born am. I marry am
GEN 20:13 wen God take mi komot from my papa house and I kon tell Sarah sey, ‘Anywhere wi go, di only tin wey yu go do to show sey yu love mi, na to tell dem sey I bi yor broda.’ ”
GEN 20:14 Den Abimelek kon give sheep, kattle, man and woman savant to Abraham. And e still give Sarah back to Abraham en husband.
GEN 20:15 Den di king sey, “Si, na my land bi all dis place wey yu dey si so, make una choose anywhere una like to stay.”
GEN 20:16 Di king kon tell Sarah, “Si, I don give 1,000 silva to yor broda, so dat evribody wey dey with yu, go si and know sey yu nor do any bad tin.”
GEN 20:17 Abraham pray to God and God kon heal King Abimelek, en wife and en wimen savants, so dat dem go fit get belle born shidren,
GEN 20:18 bikos God klose dia belle make dem nor fit born, bikos King Abimelek bin kollect Sarah, wey bi Abraham wife.
GEN 21:1 God kon visit Sarah just as E sey E go do and E kon do wetin E promise Sarah.
GEN 21:2 So Sarah get belle and e born boy for Abraham for en old age for di real time wey God don tell am.
GEN 21:3 Abraham koll di pikin wey Sarah born, Isaak.
GEN 21:4 Wen di pikin don rish eight days, Abraham sekonsaiz am, just as God kommand am make e do.
GEN 21:5 (Naw Abraham na hundred years wen Sarah born Isaak.)
GEN 21:6 Sarah kon sey, “God don make mi laf. Evribody wey hear wetin don happen, go follow mi laf.”
GEN 21:7 Sarah still sey, “Na who for fit tell Abraham sey Sarah go ever born pikin? Yet I don born boy for am for en old age!”
GEN 21:8 Di pikin grow kon stop to suck. Abraham do betta party for di day wen Isaak stop to suck.
GEN 21:9 But one day, di pikin wey Hagar, Sarah savant wey kom from Egypt, born for Abraham kon dey laf Isaak and Sarah kon si dem,
GEN 21:10 so e tell Abraham, “Make yu porshu dis slave and en pikin, bikos di slave pikin nor go fit follow my pikin share for di propaty!”
GEN 21:11 Abraham nor like wetin Sarah tok, bikos Ishmael na en pikin too.
GEN 21:12 But God tell Abraham, “Make yu nor vex about di boy or yor slave wife. Just do evritin wey Sarah dey tell yu, bikos na thru Isaak yor shidren-shidren go plenty.
GEN 21:13 But I go still make di slave pikin big, bikos en too na yor pikin.”
GEN 21:14 So very early for di next day, Abraham take some food and wota kon give Hagar. E put di food for Hagar shoulder, gi-am en pikin kon sey make dem dey go. So dem go kon dey waka anyhow for Beersheba wildaness.
GEN 21:15 Wen di wota don finish, Hagar kon put di pikin under one bush
GEN 21:16 kon go sidan for anoda side wey far from where e put di pikin; bikos e tok for en mind sey, “I nor go fit dey look am until e die.” So Hagar kon sidan far from di pikin as e dey kry.
GEN 21:17 But God hear di boy vois. God angel koll Hagar from heaven kon ask am, “Hagar! Na wetin happen? Make yu nor fear, bikos God don hear di boy vois from where e for dey kry.
GEN 21:18 So get up! Go help di boy stand make yu hold am for hand, bikos I go make en shidren-shidren plenty well-well.”
GEN 21:19 Den God kon make Hagar si one well wey get wota. Hagar go fill di wota bag wey e karry with wota and e kon give di boy wota drink.
GEN 21:20 God dey with di boy as e dey grow. E stay for di wildaness kon turn to who dey shot bow and arrow.
GEN 21:21 E stay for Paran wildaness. En mama go Egypt go bring wife kom for am.
GEN 21:22 For dat time, King Abimelek and Fikol wey bi kommander for en soja kon tell Abraham sey, “God dey with yu for evritin wey yu dey do.
GEN 21:23 Naw make yu promise for God present sey yu nor go deceive us, awa shidren and awa shidren-shidren. Make yu loyal to us for dis kountry where yu dey stay as strenja, just as wi dey loyal to yu.”
GEN 21:24 Abraham ansa, “I promise.”
GEN 21:25 But Abraham kon tell Abimelek about di well wey one of en savant seize.
GEN 21:26 Abimelek ansa, “I nor know who do dis tin and yu nor even tell mi. I neva hear about am until today.”
GEN 21:27 Abraham take some sheep and kattle kon give King Abimelek and di two of dem kon enter agriment.
GEN 21:28 Den Abraham separate seven iyu lamb from di oda animals
GEN 21:29 and Abimelek kon as am, “Wetin make yu do like dat?”
GEN 21:30 Abraham ansa, “Yu must take dis seven iyu lamb from mi, so dat e go show sey I true-true dig dis well.”
GEN 21:31 Dat na why e koll di place Beersheba, bikos Abraham and Abimelek enter agriment for der.
GEN 21:32 Afta dem don make dis agriment for Beersheba, Abimelek and Fikol kon go back to Filistia.
GEN 21:33 Den Abraham plant tamarisk tree for Beersheba and e woship di Oga God wey bi di God forever for der.
GEN 21:34 Abraham stay for Filistia pipol land tey small.
GEN 22:1 So afta sometaim, God kon test Abraham. God koll am, “Abraham!” Abraham ansa, “Na mi bi dis!”
GEN 22:2 God kon sey, “Make yu take yor pikin Isaak, yor only boy wey yu love and make una dey go Moraya! Den yu go offa am to mi as ofrin for one mountin wey I go show yu.”
GEN 22:3 For early morning di next day, Abraham kon get up go ready en donkey. E take two of en savants follow body plus en pikin, Isaak. Wen e don kut di wood for di ofrin, e kon bigin go di place wey God tell am.
GEN 22:4 For di third day, Abraham kon si di place from far.
GEN 22:5 So e kon tell en savants, “Make una two wait for here with di donkey, but mi and di boy go-go up for der. Wi go woship God kon kom back.”
GEN 22:6 Abraham take di wood for di ofrin kon karry am put for en pikin Isaak head. Den e take di fire and di knife and di two of dem kon waka dey go.
GEN 22:7 Isaak ask en papa, “My papa?” Abraham ansa, “My pikin, na wetin?” Isaak kon sey, “Si di fire and di wood for here, but where di lamb wey wi go use for di sakrifice?”
GEN 22:8 Abraham ansa en pikin, “God go provide di lamb wey wi go use for di ofrin.” Den di two of dem kon waka go.
GEN 22:9 Wen dem rish di place where God tok about, Abraham kon build altar for der and e arrange di wood on-top. Den e tie Isaak hand and leg kon put am on-top di altar.
GEN 22:10 Den Abraham take di knife won kon kill en pikin.
GEN 22:11 But God angel koll am from heaven, “Abraham! Abraham!” Abraham ansa, “Si mi for here!”
GEN 22:12 Di angel kon sey, “Make yu nor do di boy anytin, nor wound am. Naw! I don know sey yu dey fear God, bikos yu even ready to kill yor only pikin for mi.”
GEN 22:13 Abraham look up kon si one ram for en back, wey dey for trap for di bush. So e go karry di ram kon offa am to Oga God instead of en pikin.
GEN 22:14 So Abraham koll di place, “Jehovah-Jireh, wey mean (God dey provide).” And till today dem dey sey, “For God mountin, E go provide evritin.”
GEN 22:15 God angel koll Abraham again from heaven
GEN 22:16 kon tell am, “God sey, ‘I promise yu with my own name sey, bikos yu don do like dis kon give mi yor son, yor only pikin,
GEN 22:17 I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
GEN 22:18 Bikos yu don obey mi, evribody go get blessing, bikos I go bless yor shidren-shidren.’ ”
GEN 22:19 Den Abraham go back go meet en savants and dem kon go back to Beersheba, where Abraham dey stay.
GEN 22:20 Afta all dis tins, dem kon tell Abraham sey, “Milka sef don born shidren for yor broda Nahor
GEN 22:21 and na Uz bi first-born, en brodas na Buz, Kemuel (Aram papa),
GEN 22:22 Kesed, Hazo, Pildash, Jidlaf and Betuel.”
GEN 22:23 (Naw Betuel kon bi Rebekah papa.) Dis na di eight shidren wey Milka born for Nahor, Abraham broda.
GEN 22:24 En savant Reumah still born shidren for am and dia names na: Tebah, Gaham, Tahash and Maaka.
GEN 23:1 Sarah stay for one hundred and twenty-seven years.
GEN 23:2 E die for Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. Abraham mourn and kry for Sarah.
GEN 23:3 Den Abraham get up from where e for dey mourn en wife wey die kon tell Het pikin dem sey,
GEN 23:4 “Na strenja I bi for una land and I go soon komot here, so make una give mi land where I go beri my wife put.”
GEN 23:5 Het pikin dem ansa Abraham,
GEN 23:6 “Oga, make yu listin to us. Yu bi prince wey get betta pawa among us! Yu fit beri yor wife for di best land wey wi get for here. All of us go happy to give yu land make yu beri yor wife put.”
GEN 23:7 Abraham stand up kon bow for Het shidren.
GEN 23:8 Den e tell dem, “If una gri sey make I beri my wife for here, den make una hear wetin I won tok. Make una ask Efron, Zohar son
GEN 23:9 if e go sell Makpelah grave wey bi en own give mi; e dey di end for en field. Make e sell am give mi for evribody front for di normal prize, so dat I go beri my wife for der and e go kon bi awa burial groun.”
GEN 23:10 (Naw Efron sidan with Hit shidren.) Efron wey bi Hit pesin kon ansa Abraham for front of Het shidren and evribody wey dey kom thru di town gate sey,
GEN 23:11 “Okay my oga! I go sell both di field and di grave give yu. For my pipol front, I sell am give yu. Make yu go beri yor wife for der.”
GEN 23:12 Abraham bow again for di pipol
GEN 23:13 kon tell Efron for dia front sey, “Abeg, make una listin to mi. I go pay yu di prize for di field. Take am from mi, so dat I go fit go beri my wife for der.”
GEN 23:14 Efron ansa Abraham,
GEN 23:15 “My oga, di land na 400 silva, but dat one nor mean anytin at-all. So go beri yor wife for der.”
GEN 23:16 Abraham agri with Efron prize, e give di money to am kon dey tok make evribody for hear am, “Dis na 400 silva, just as dem dey measure am dat time.”
GEN 23:17 So Abraham kon buy Efron field for Makpelah, wey dey near Mamre, plus di field, di grave and all di land wey dey near am
GEN 23:18 and all dem kon bi en propaty. So Het shidren and evribody wey dey enter di gate for Efron town kon bi en witness.
GEN 23:19 Afta evritin, Abraham beri Sarah en wife for di grave wey dey Makpelah field near Mamre (wey bi Hebron naw) for Kanaan land.
GEN 23:20 Abraham buy di field and di grave from Het shidren as where dem go dey beri pipol put.
GEN 24:1 Abraham don old well-well and God don bless am for evritin.
GEN 24:2 One day, Abraham tell en savant wey old pass, di one wey dey guide di house sey, “Make yu put yor hand under my lap.
GEN 24:3 Den promise with di Oga God name, di God for heaven and eart sey yu nor go allow my pikin marry one for doz local Kanaan wimen.
GEN 24:4 Instead, make yu go my village go meet my relashon kon find wife among dem for my pikin Isaak.”
GEN 24:5 Di savant ask, “But wetin I go do if di woman nor gri follow mi kom back to dis far land? Make I take yor pikin go back to di land wey yu from kom?”
GEN 24:6 Abraham ansa, “Make yu nor take my pikin go back to dat land!
GEN 24:7 Oga wey bi di God for heaven wey take mi komot from my papa house and di land wey my pipol dey, naim promise mi wen E promise sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ So God go send en angel go for yor front, so dat yu go si one good wife for der kon bring kom give my pikin.
GEN 24:8 But if di woman nor won follow yu kom back, dis swear nor go do yu anytin. But make yu nor take my pikin go back to dat land!”
GEN 24:9 So di savant put en hand under en oga Abraham lap kon promise sey e go do as Abraham tok.
GEN 24:10 Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town.
GEN 24:11 E make di kamel knee down near di well wey dey outside di town. Dat na evening time wen di wimen dey kom fetch wota.
GEN 24:12 E kon pray, “My Oga God, wey bi my masta Abraham God, make Yu guide mi today. Make Yu dey good to my oga Abraham.
GEN 24:13 I stand near dis well and di pipol wey dey stay dis town, dia dotas go kom fetch wota.
GEN 24:14 I go tell one among dem sey, ‘Abeg make yu give mi wota drink.’ Den make di one wey Yu don choose for yor savant Isaak ansa, ‘Make yu drink and I go give yor kamel make dem drink too.’ Like dis, I go know sey Yu dey good to my oga.”
GEN 24:15 Before e pray finish, Rebekah kon dey kom with en wota pot for en shoulder. E bi Betuel pikin and en grand-mama na Milka (Milka na Abraham broda wife, Nahor).
GEN 24:16 Di girl fine well-well. E neva sleep with anybody for en life. Rebekah go di well, fetch wota put for en pot kon dey kom back.
GEN 24:17 Den Abraham savant run go meet am kon sey, “Abeg make yu give mi small wota drink from yor pot.”
GEN 24:18 Rebekah ansa, “My oga, make yu drink,” den di girl kwik-kwik karry en pot put for en hand kon gi-am wota drink.
GEN 24:19 Wen di girl don do like so, e kon sey, “I go fetch wota for yor kamel until dem don drink beleful too.”
GEN 24:20 So di girl kon pour all di wota wey dey en pot inside where di kamels go for drink, den e run go back go fetch more wota until all di kamel don drink beleful.
GEN 24:21 Di man just kwayet dey look am just to know if God don make en travel get head or not.
GEN 24:22 Afta di kamels don drink finish, di man bring one gold ring wey dem dey put for nose and two gold shain for waist kon gi-am to di girl.
GEN 24:23 Den e ask di girl, “Na wish pesin pikin yu bi?” Abeg make yu tell mi, “Yor papa go get any empty room for mi wey I fit sleep put dis nite?”
GEN 24:24 Rebekah ansa, “I bi Betuel pikin and na Milka and Nahor born Betuel.
GEN 24:25 Yes, wi get plenty food for yor kamel and wi get room for strenjas.”
GEN 24:26 Di savant kon bow for groun woship God.
GEN 24:27 E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”
GEN 24:28 Di girl kon run go house go tell en family evritin wey happen.
GEN 24:29 Naw, Rebekah get one broda wey en name na Laban and e run go meet di man for di well.
GEN 24:30 Wen e si di shain for en sista hand and di ring for en nose kon hear wetin en sista tok wen e sey, “Dis na wetin di man tok”, e run go meet di man for where e for still stand near en kamels. Laban kon tell am,
GEN 24:31 “Make yu kom stay with us, bikos God don bless yu! Wetin make yu stand for outside di town wen I get room for yu and I go fit prepare somewhere for yor kamels?”
GEN 24:32 So di man follow Laban go house and Laban pak all di load komot di kamel back kon klean, feed and give di man and di kamel drivers wota make dem take wosh dia legs.
GEN 24:33 Wen dem serve food for dem, e kon sey, “I nor go chop until I don tok wetin I won tok.” Laban ask am, “Wetin yu won tok.”
GEN 24:34 E kon sey, “I bi Abraham savant.
GEN 24:35 God don really bless my oga and e get evritin wey e wont. Oga God don gi-am sheep, kattle, gold, silva, man and woman savants, kamel and donkey.
GEN 24:36 My oga wife Sarah born only one pikin for am wen dem don old and my oga don give di pikin evritin wey e get.
GEN 24:37 My oga make mi swear wen e sey, ‘For here wey I dey stay, yu nor go marry any Kanaan woman give my pikin Isaak,
GEN 24:38 but make yu go my family house go find wife for my pikin.’
GEN 24:39 “But I tell my oga sey, ‘Wot of if di woman sey e nor go follow mi kom?’
GEN 24:40 E kon ansa mi, ‘God wey I dey serve, go send en angel follow yu go. E go make yor journey well and yu go si wife for my pikin from among my papa family.
GEN 24:41 Yu go dey free from di swear if yu go meet my family and dem nor gri give di girl to yu. True-true, yu go dey free.’
GEN 24:42 “Wen I rish di well today, I kon pray sey, ‘My Oga wey bi my oga Abraham God, if Yu know sey Yu go make my journey well, make evritin happen as dem suppose bi.’
GEN 24:43 As I stand near di well so. Wen di rite girl go kom fetch wota, I go tell am, ‘Make yu give mi wota from yor pot make I drink.’
GEN 24:44 Den di girl go ansa, ‘Make yu drink and I go fetch give yor kamels too.’ Den na dat girl go bi di one wey di Oga God don choose for my oga pikin.
GEN 24:45 “Before I pray finish inside my heart, I kon si Rebekah dey kom fetch wota with en wota pot for en shoulder. So I tell am, ‘Make yu give mi wota drink.’
GEN 24:46 E kon kwik-kwik put en pot down from en shoulder kon sey, ‘Make yu drink and I go give yor kamels wota too.’ So I drink and e kon give my kamel dem drink too.
GEN 24:47 Den I ask am, ‘Na wish pesin pikin yu bi?’ Di girl ansa, ‘I bi Betuel wey en papa na Nahor and na Milka born Betuel for Nabor.’ So, I kon put di ring for en nose and di shain for en hand.
GEN 24:48 “Den I bow woship God wey bi my oga Abraham God, bikos na-im lead mi for di korrect way, so dat I go meet my oga Abraham broda Nahor grand-pikin.
GEN 24:49 Naw, if una go show sey una dey good to my oga, make una tell mi. But if una nor gri, make una still tell mi too, so dat I go-go back.”
GEN 24:50 Den Laban and Betuel ansa, “Dis na as God wont am. Wetin wi wont nor mean anytin.
GEN 24:51 Na Rebekah stand so for yor front. Make yu take am dey go, so dat e go bi yor oga Abraham pikin wife, just as God don tok am.”
GEN 24:52 Wen Abraham savant hear wetin dem tok, e bow face groun kon woship God.
GEN 24:53 Den e bring gold, silva, klot and oda tins kon give dem to Rebekah. E still give some betta gifts to Rebekah broda and mama.
GEN 24:54 Afta, en and di men wey dey with am kon chop and dem stay der dat nite till day break. Wen dem wake-up di next morning, Abraham savant kon sey, “Make I dey go naw go meet my oga.”
GEN 24:55 But Rebekah broda and mama kon ansa, “Make di girl still stay with us for like ten days, den e fit kom meet una.”
GEN 24:56 But di savant tell dem, “Make una nor keep mi, God don make my journey get head. Make una let mi go meet my oga naw.”
GEN 24:57 Den dem sey, “Make wi hear from di girl mout.”
GEN 24:58 So dem koll Rebekah kon ask am, “Yu wont follow dis man go?” E ansa, “Yes! I go follow am.”
GEN 24:59 So dem kon give dia sista Rebekah to di man, but some savant follow am, with Abraham savant and en men.
GEN 24:60 Dem bless Rebekah kon sey: “Awa sista, yu go bi mama to tazon-tazon pipol! Yor shidren-shidren pawa go strong pass dia enemies own.”
GEN 24:61 Den Rebekah and en wimen savant klimb di kamel kon follow Abraham savant. So Abraham savant take Rebekah go.
GEN 24:62 Naw, Isaak kom from Beer Lahai Roi, bikos e dey stay for Negev.
GEN 24:63 As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
GEN 24:64 Wen Rebekah look, e kon si Isaak. E kom down from en kamel
GEN 24:65 kon ask Abraham savant, “Na who bi dat man for di field wey dey waka kom meet us?” Di savant ansa, “Na my oga bi dat.” So di girl take en klot kon kover ensef well.
GEN 24:66 Di savant tell Isaak evritin wey happen.
GEN 24:67 Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.
GEN 25:1 Abraham kon marry anoda wife and di woman name na Keturah.
GEN 25:2 Di woman kon born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah.
GEN 25:3 Jokshan kon bi Sheba and Dedan papa. Den di shidren wey Dedan born na Asshur, Letush and Leumm.
GEN 25:4 Midian sons na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis na Keturah shidren-shidren.
GEN 25:5 Evritin wey Abraham get, e gi-am to en pikin Isaak.
GEN 25:6 But wen Abraham still dey alive, e give gift to di shidren wey en oda wifes born for am kon send dem go east, so dat dem go dey fast and nor disturb Isaak.
GEN 25:7 Abraham stay for one hundred and seventy-five years.
GEN 25:8 Den Abraham die for betta old age. E really old and live betta life. E die go join en grand-grand papa dem.
GEN 25:9 En pikin Isaak and Ishmael kon beri am for Makpelah grave near Mamre, for Efron field and dis Efron na Zohar wey kom from Hit, pikin.
GEN 25:10 Dis na di field wey Abraham buy from Het shidren. So dem beri Abraham and en wife Sarah for der.
GEN 25:11 Afta Abraham don die, God kon bless en pikin Isaak. Isaak dey stay near Beer Lahai Roi.
GEN 25:12 Dis na di story about di pikin Ishmael wey Hagar di woman wey kom from Egypt; Sarah savant born give Abraham.
GEN 25:13 Dis na Ishmael pikin names akordin to as dem write am: Nebaiot (Ishmael first-born), Kedar, Adbeel, Mibsam,
GEN 25:14 Mishma, Dumah, Massa,
GEN 25:15 Hadad, Tema, Jetur, Nafish and Kedemah.
GEN 25:16 Dis na Ishmael pikin and dis na dia names for where dem stay and kamp put, bikos dem bi twelf prince, akordin to dia family.
GEN 25:17 Ishmael stay for 137 years. E die kon go join en grand-grand papa.
GEN 25:18 E shidren-shidren kon stay for Havilah go rish Shur wey pass Egypt go rish Asshur. Dem nor stay near dia relashon at-all.
GEN 25:19 Dis na di story about Abraham pikin Isaak. Abraham na Isaak papa.
GEN 25:20 Wen Isaak na forty years, e kon marry Rebekah wey bi Betuel, di Aramean pikin and dis Betuel kom from Paddan Aram. Rebekah broda na Laban di Aramean.
GEN 25:21 Isaak pray to Oga God for en wife, bikos e neva born. God ansa en pray and en wife Rebekah kon get belle.
GEN 25:22 But di shidren kon dey struggol inside am, so di woman kon sey, “If na so e go bi, I nor sure sey I like get belle!” So di woman ask God
GEN 25:23 and Oga God kon tell am, “Na two nashons dey yor belle and two pipol go kom out from inside yu. One go dey strong pass di oda one and di senior one, go serve di yonga one.”
GEN 25:24 Wen di time don rish for Rebekah to born, na two pikin dey en belle.
GEN 25:25 Di first one kom out, evriwhere for en body red and hair full am, so dem kon koll am Esau.
GEN 25:26 Wen en broda kom out, e hold Esau leg, so dem kon koll am Jakob. Isaak na sixty years wen Rebekah born dem.
GEN 25:27 Wen di boys don big, Esau kon sabi katch animals; e sabi di work well-well, but Jakob na kwayet man wey dey stay house.
GEN 25:28 Isaak love Esau, bikos e like fresh bush meat, but Rebekah love Jakob.
GEN 25:29 One day, Jakob kook some stew and wen Esau kom back from di bush, e kon dey hongry.
GEN 25:30 So Esau tell Jakob, “Make yu give mi some stew make I chop, bikos hongry dey kill mi!” (Dat na di resin why dem dey still koll am, Edom.)
GEN 25:31 But Jakob ansa, “Make yu first gri sey na mi bi senior.”
GEN 25:32 Esau kon sey, “Si, na die I dey so! Dis senior tin nor even dey yuzful to mi!”
GEN 25:33 But Jakob sey, “Make yu first swear about am.” So Esau swear kon give di senior pozishon to Jakob.
GEN 25:34 Den Jakob give Esau some bread and stew; Esau chop kon drink wota den e get up waka komot der. Na so Esau take sell en rite as senior give Jakob.
GEN 26:1 Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay.
GEN 26:2 God appear to Isaak kon tell am, “Make yu nor go Egypt; but make yu stay for di land wey I go show yu.
GEN 26:3 Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.
GEN 26:4 I go make yor shidren plenty like di stars wey dey di sky and I go give dem all dis land. I go bless all di nashon for di world with yor shidren-shidren name.
GEN 26:5 All dis tins go happen, bikos Abraham obey mi kon keep all my words; my kommand, my rules and my laws.”
GEN 26:6 So Isaak kon stay for Gerar.
GEN 26:7 Wen di men for di place ask am about en wife, e kon tell dem sey, “Na my sista.” Fear nor fit let am sey, “Na my wife,” bikos e tink for en mind sey, “If I sey na my wife, di men for dis place go kill mi make dem for fit get Rebekah, bikos e too fine.”
GEN 26:8 Afta Isaak don stay der tey, Abimelek wey bi Filistia pipol king kon look from window and e si Isaak dey play with en wife Rebekah.
GEN 26:9 So Abimelek koll Isaak kon sey, “Dis woman na yor wife! Wetin make yu sey, ‘Na my sista e bi?’ ” Isaak ansa, “Na bikos I tink sey somebody fit kill mi just to get am.”
GEN 26:10 Den di king sey, “Wetin make yu do us like dis? Wot of if one of my men kon go sleep with yor wife? Den yu for don make us sin!”
GEN 26:11 So Abimelek kommand all en pipol sey, “Anybody wey tosh dis man or en wife, must die.”
GEN 26:12 Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.
GEN 26:13 Isaak kon rish well-well. E dey prosper more-more until evribody know am.
GEN 26:14 E get many sheep and kattle and en savant many well-well, so Filistia pipol kon dey jealous am.
GEN 26:15 So Filistia pipol karry san-san kon kover all di well wey Isaak papa savants, dig for di time wey Abraham dey der.
GEN 26:16 Den Abimelek kon tell Isaak, “Make yu komot from here go anoda place, bikos di pawa wey yu get, don strong pass awa own.”
GEN 26:17 So Isaak komot der kon go stay for Gerar Valley.
GEN 26:18 Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before.
GEN 26:19 Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota,
GEN 26:20 di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
GEN 26:21 En savants dig anoda well, but dem still follow am drag am too, so Isaak koll di well, Sitnah.
GEN 26:22 Den e komot from der kon go dig anoda well. Nobody follow am kworel for dis one, so Isaak kon koll am Rehobot dey sey, “Naw Oga God don make room for us and wi go prosper for dis land.”
GEN 26:23 From der, Isaak kon go Beersheba.
GEN 26:24 God appear to am dat nite kon sey, “Na mi bi yor papa Abraham God. Make yu nor fear, bikos I dey with yu. Bikos of my savant Abraham, I go bless yu kon make yor shidren-shidren plenty.”
GEN 26:25 Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
GEN 26:26 Naw, King Abimelek don kom visit am from Gerar with en friend Ahuzzat and Fikol wey bi di sojas oga.
GEN 26:27 Isaak kon ask dem, “Wetin make una kom meet mi? Nor bi bikos una hate mi, naim make una porshu mi?”
GEN 26:28 Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,
GEN 26:29 so dat yu nor go ponish us, just as wi nor ponish yu, but wi dey always trit yu well, before wi even porshu yu with peace. Naw God don bless yu.”
GEN 26:30 So Isaak do party for dem kon celebrate.
GEN 26:31 Very early for di next morning, Isaak and King Abimelek kon make peace with each oda. Isaak kon escort dem and dem kon komot without wahala.
GEN 26:32 Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.”
GEN 26:33 So Isaak koll di well Shibah; dat na why dem dey koll di town till today, Beersheba.
GEN 26:34 Wen Esau don rish forty years, e kon marry Judit wey bi Beeri pikin and Beeri kom from Hit. E still marry Basemat wey bi Elon wey Het pikin born.
GEN 26:35 Di matter nor kon make Isaak and Rebekah, happy.
GEN 27:1 Wen Isaak don old well-well and e nor dey si well again, e koll en senior pikin Esau kon tell am, “My pikin!” Esau ansa, “Papa, na mi bi dis!”
GEN 27:2 Isaak tell am, “Since I don old, I fit die anytime.
GEN 27:3 So make yu take yor weapons go katch animal kom for mi.
GEN 27:4 Make yu prepare betta food for mi, di kind one wey yu know sey I love, den bring am kom meet mi. Den I go chop kon bless yu before I die.”
GEN 27:5 As Isaak dey tok to Esau, Rebekah dey one korna dey listin. Wen Esau don go katch di animal,
GEN 27:6 Rebekah kon tell en pikin Jakob, “Si, I hear wen yor papa dey tell yor broda Esau sey,
GEN 27:7 ‘Make yu go katch animal for mi kon kook dem make I chop, den I go bless yu for Oga God present, before I go die.’
GEN 27:8 Naw, my pikin, make yu do as I tell yu!
GEN 27:9 Go where di animals dey kon kill one of di goats. I go prepare dem make e sweet well-well as yor papa dey like am.
GEN 27:10 Den yu go take am go give yor papa. E go chop am kon bless yu before e die.”
GEN 27:11 But Jakob kon tell en mama, “My broda Esau get hair full body and my skin smooth!
GEN 27:12 My papa fit tosh mi! Den e go tink sey I dey fool am and e go curse mi instead of am to bless mi.”
GEN 27:13 So en mama tell am, “My Pikin! Any curse wey dem curse yu, I go use my head karry am! Make yu just obey mi! Just go get dem for mi!”
GEN 27:14 So Jakob take di goat go give en mama. Di woman kon kook some sweet food, just as Isaak dey like am.
GEN 27:15 Den Rebekah take en senior pikin, Esau best klot wey e get for house kon wear am for Jakob.
GEN 27:16 E put di goat skin for en hand and di part wey smooth for en neck.
GEN 27:17 Den di woman karry di food wey e make, give Jakob.
GEN 27:18 Jakob go meet en papa kon sey, “My papa!” Isaak ansa, “Na mi bi dis. Wish of my pikin dey tok?”
GEN 27:19 Jakob ansa en papa, “Na mi Esau, yor first pikin. I don do as yu tell mi. Naw sidan make yu chop, so dat yu go bless mi.”
GEN 27:20 But Isaak ask en pikin, “Na how yu take kill di animal just naw just naw?” Jakob ansa, “Na di Oga yor God help mi.”
GEN 27:21 Den Isaak tell Jakob, “My pikin, make yu kom near mi, so dat I go fit tosh yu kon know if yu really bi Esau.”
GEN 27:22 So Jakob waka go near en papa Isaak and Isaak tosh am kon sey, “Di vois bi like Jakob own, but di hand bi like Esau own.”
GEN 27:23 E nor know Jakob bikos hair full en hand like en broda Esau own. So Isaak bless Jakob.
GEN 27:24 Den e ask am, “Yu sure sey na yu bi Esau?” Jakob ansa, “Na mi na!”
GEN 27:25 Isaak kon tell am, “My pikin, make yu bring some for di bush meat make I chop. Den I go bless yu wen I chop finish.” So Jakob take some for di bush meat go give en papa and Isaak chop am. E still gi-am wine drink too.
GEN 27:26 Den en papa Isaak kon tell am, “My pikin, make yu kom here kon kiss mi.”
GEN 27:27 So Jakob waka go kiss am. Wen Isaak feel as en klot dey smell, e kon bless am sey, “Yes, my pikin dey smell like sey e dey inside bush wey God don bless.
GEN 27:28 Make God give yu di dew from di sky and di good tins wey dey di eart, plus many korn and wine.
GEN 27:29 Pipol go serve yu and nashons go bow to yu. Na yu go bi oga ova yor broda and yor mama shidren go bow for yu. Anybody wey curse yu, curse go dey en head and blessing go follow doz wey bless yu.”
GEN 27:30 As Isaak just bless Jakob finish and as Jakob dey waka leave am, en broda Esau just dey kom back.
GEN 27:31 Esau too prepare sweet food won go give en papa. Esau kon tell en papa. “My papa, get up make yu chop some bush meat wey yor pikin kook, so dat yu go bless mi.”
GEN 27:32 En papa Isaak ask am, “Na who yu bi?” Esau ansa, “Na mi bi yor first-born, Esau!”
GEN 27:33 Isaak kon dey shake well-well, so e ask, “Den na who kon give mi bush meat chop? I chop evritin before yu kom and I bless di pesin. And blessing go really follow am!”
GEN 27:34 Wen Esau hear wetin e papa tok, e shaut kon dey kry well-well. E kon tell en papa, “Papa, make yu bless mi too!”
GEN 27:35 But Isaak ansa, “Yor broda Jakob don kon deceive mi kollect yor blessings.”
GEN 27:36 Esau still sey, “En name really na Jakob! E don kollect two tins for my hand naw! E first kollect my rite as senior and naw si, e don take my blessing!” Den e ask en papa, “Yu nor keep any blessing for mi?”
GEN 27:37 Isaak ansa, “Si! I don make am oga ova yu. I don make evribody wey rilate to am to bi en savant kon bless am with many korn and wine. Wetin dey naw wey I go fit do for yu, my pikin?”
GEN 27:38 Esau kon tell en papa, “My Papa, so yu nor get only one blessing for mi? Abeg make yu bless mi too!” Den Esau kon dey kry well-well.
GEN 27:39 So en papa Isaak kon tell am, “True-true, where yu dey nor go get di good wey di land dey give and di dew for di sky nor go fall for yor place.
GEN 27:40 Na so-so swod yu go take dey fight and yu go serve yor broda. But wen e don taya yu, den yu go free yorsef from all dis tins.”
GEN 27:41 So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”
GEN 27:42 Wen Rebekah hear wetin en senior pikin, Esau tok, e koll en yonga pikin Jakob kon tell am, “Si, yor broda Esau dey try to revensh, so e don sey e go kill yu.
GEN 27:43 Naw, my pikin make yu do wetin I tok. Run naw-naw go meet my broda, Laban for Haran.
GEN 27:44 Make yu stay with am small, until yor broda Esau nor dey vex for yu again.
GEN 27:45 Make yu stay der until Esau nor dey vex and e don forget evritin wey yu do am. Den I go send pesin make dem bring yu kom back. I nor fit luz di two of una for di same day.”
GEN 27:46 Den Rebekah tell Isaak, “I nor dey happy bikos of dis Het dotas. E betta make I die, instead of Jakob to marry one among dis Het dotas wey dey dis land!”
GEN 28:1 So Isaak koll Jakob kon bless am. Den e kommand am sey, “Make yu nor marry any Kanaan woman!
GEN 28:2 Make yu dey go Paddan Aram naw-naw! Make yu go Betuel house wey bi yor mama papa kon find wife for der among yor mama broda Laban dotas.
GEN 28:3 God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon.
GEN 28:4 E go give yu and yor shidren-shidren di blessing wey E give Abraham, so dat una go take di land wey God give Abraham; di land wey yu just dey stay as strenjas.”
GEN 28:5 So Isaak send Jakob go and e go Paddan Aram go meet Betuel pikin Laban, di Aramean wey bi en mama Rebekah, broda.
GEN 28:6 Esau si sey Isaak don bless Jakob kon send am go Paddan Aram, so dat e go get wife for der. As Isaak dey bless am, e kommand am, “Make yu nor marry Kanaan woman.”
GEN 28:7 Jakob obey en papa and mama kon go Paddan Aram.
GEN 28:8 Na den Esau kon know sey en papa nor like di wimen from Kanaan.
GEN 28:9 So Esau go Ishmael kon marry Mahalat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael, Abraham pikin born am. E marry dis one join di wifes wey e get before.
GEN 28:10 But Jakob komot Beersheba kon go Haran.
GEN 28:11 E rish one place where e stay small, bikos evening don dey rish. E take one among di stones kon put am near en head. Den sleep kon katch am for dat place
GEN 28:12 and e kon dream. E si one strait road wey from eart go rish heaven and God angels dey waka up-and-down for di road,
GEN 28:13 den Oga God stand for di top. God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.
GEN 28:14 Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.
GEN 28:15 I go dey with yu! I go guide yu for anywhere wey yu dey go kon bring yu kom back to dis land. I nor go leave yu until I don do wetin I promise yu!”
GEN 28:16 Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”
GEN 28:17 Bikos e dey fear, e kon sey, “Wish kind wonderful place bi dis! Dis nor bi any oda place, but na God house! Dis na heaven gate!”
GEN 28:18 Very early for di next morning, Jakob take di stone wey e put near en head kon keep am as holy stone. Den e pour oil on-top am.
GEN 28:19 E koll di place Bethel, even doh di name before na Luz.
GEN 28:20 Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear
GEN 28:21 and I go back to my papa house sey nor-tin do mi, den di Oga God go bi my God.
GEN 28:22 Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”
GEN 29:1 So Jakob kon dey travel until e rish di land where pipol dey for east.
GEN 29:2 For di field, e si one well and three sheep liedan near di well, bikos di sheep dey drink wota from di well.
GEN 29:3 Wen all di sheep don gada for der, di pesin wey dey guide dem go roll di stone komot from di well mout for di sheep to drink wota. Den, afta dem don drink finish e go put di stone back for di well mout.
GEN 29:4 Jakob kon ask am, “My brodas, where una from kom?” Dem ansa, “Na from Haran.”
GEN 29:5 So Jakob tell dem, “Una know Laban wey bi Nahor grand-pikin?” Dem ansa, “Wi know am.”
GEN 29:6 Jakob kon ask, “E dey okay.” Dem ansa, “Yes! E dey okay. Naw, si en dota Rashel dey kom with di sheep.”
GEN 29:7 Den Jakob sey, “Since na still aftanoon, e neva rish time to gada di sheep. Make yu give di sheep wota kon let dem still go chop.”
GEN 29:8 Dem kon ansa, “Wi nor fit. Na only wen di sheep dey togeda and wi don roll di stone komot for di mout, dat na di only time wey wi fit give dem wota drink or wosh dem.”
GEN 29:9 As e still dey tok to dem, Rashel rish der with en papa sheep, bikos na en dey guide dem.
GEN 29:10 Wen Jakob si Rashel wey bi en mama broda Laban dota and di sheep, e kon waka go remove di stone for di well mout kon give en mama broda sheep wota make dem drink.
GEN 29:11 Den Jakob kiss Rashel kon dey kry.
GEN 29:12 Wen Jakob tell Rashel sey e rilate to en family and na Rebekah, Laban sista bi en mama, Rashel run go tell en papa.
GEN 29:13 Wen Laban hear wetin en pikin tok about Jakob, wey bi en sista pikin, e kon run go meet am. E hold am tight kon kiss am, den e karry am go house. Jakob tell Laban how e take rilate to am.
GEN 29:14 Den Laban tell am, “Yu really bi my own flesh and blood.” So Jakob stay with Laban for one mont.
GEN 29:15 Den Laban tell Jakob, “Yu won work for mi for nor-tin bikos yu rilate to mi? Make yu tell mi wetin yu wont make I take pay yu.”
GEN 29:16 (Laban get two girl pikin; di senior one name na Leah and di yonga one na Rashel.
GEN 29:17 Leah eyes fine well-well, but Rashel get betta body with fine shape.)
GEN 29:18 Since Jakob don love Rashel well-well, e kon sey, “I go serve yu for seven years, so dat I go fit marry yor yonga dota, Rashel.”
GEN 29:19 Laban ansa, “E betta make I gi-am to yu dan any oda man. Make yu stay with mi.”
GEN 29:20 So Jakob work for seven years to marry Rashel. But di seven years bi like seven days for en eye, bikos di way e love Rashel, strong well-well.
GEN 29:21 So Jakob kon tell Laban, “Make yu give mi my wife make I marry, bikos di seven years don komplete.”
GEN 29:22 So Laban invite all di pipol for dat place kon do party.
GEN 29:23 For dat evening, e bring en dota, Leah kon give Jakob and Jakob kon marry am.
GEN 29:24 (Laban give en savant Zilpah to Leah, so dat e go bi Leah savant.)
GEN 29:25 For morning, Jakob kon find out sey na Leah e sleep with! So Jakob tell Laban, “Wetin yu do mi so! Nor bi bikos of Rashel make mi work for yu? Wetin make yu deceive mi?”
GEN 29:26 Laban ansa, “Awa tradishon for here nor dey gri make di yonga sista first en senior sista marry.
GEN 29:27 Make yu do evry normal tin wey yu suppose do for di senior one, den I go give yu di yonga one, afta yu don work for mi for anoda seven years.”
GEN 29:28 Jakob kon do as Laban tok. Wen Jakob don do all di tins wey e suppose do, Laban kon gi-am en sekond pikin, Rashel.
GEN 29:29 (Laban give en savant Bilhah to Rashel, so dat e go bi en savant.)
GEN 29:30 Jakob kon sleep with Rashel too. E love Rashel pass Leah, so e work for Laban for anoda seven years.
GEN 29:31 Wen God si sey Jakob nor love Leah like dat, E kon make am get belle, while Rashel nor fit born.
GEN 29:32 So Leah get belle kon born boy. E name am Reuben kon sey, “God don sorry for mi, bikos of my kondishon. True-true, my husband go love mi naw.”
GEN 29:33 Leah get belle again kon born anoda boy. E kon sey, “Bikos God hear sey my husband nor love mi, E don give mi dis one too.” So Leah kon koll am Simeon.
GEN 29:34 Leah get belle again and e born anoda boy. E kon sey, “Naw dis time, my husband go love mi, bikos I don born three boy pikin.” Dat na why e koll am Levi.
GEN 29:35 Leah still get belle again and e born anoda boy. E kon sey, “Dis time I go praiz God.” Dat na why e koll am Judah. Den Leah nor kon born again.
GEN 30:1 Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”
GEN 30:2 Jakob kon dey vex with Rashel so e sey, “Na mi bi God wey neva give yu pikin?”
GEN 30:3 Rashel ansa, “I wont make yu sleep with my savant Bilhah, so dat e go born shidren for mi and I go kon get my own family thru am.”
GEN 30:4 So Rashel give en savant Bilhah to Jakob and Jakob kon sleep with am.
GEN 30:5 Bilhah get belle kon born boy pikin for Jakob.
GEN 30:6 Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan.
GEN 30:7 Rashel savant Bilhah kon get belle again for Jakob and e still born boy.
GEN 30:8 Den Rashel sey, “I don really fight betta fight with Leah, my sista and I don win.” So e koll di pikin Naftali.
GEN 30:9 Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob.
GEN 30:10 E nor too tey before Leah savant Zilpah born boy for Jakob.
GEN 30:11 Leah kon sey, “E good well-well!” So e koll di pikin Gad.
GEN 30:12 Den Leah savant Zilpah born anoda pikin for Jakob.
GEN 30:13 Leah kon sey, “My belle dey sweet mi, bikos wimen go dey happy well-well, bikos of mi!” So e koll di pikin Asher.
GEN 30:14 So wen dem dey do di wheat feast, Reuben komot kon si some mandrake plants for di field, den e bring dem kon give en mama Leah. Rashel kon tell en sista Leah, “Make yu give mi some for di plant wey yor pikin bring.”
GEN 30:15 But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?” Rashel ansa, “Okay, make yu give mi some mandrake and e go sleep with yu dis nite.”
GEN 30:16 Wen Jakob kom back from di field dat evening, Leah go meet am kon sey, “Yu must sleep with mi today o-o, bikos I don pay to get yu with my pikin mandrake.” So Jakob sleep with am dat nite.
GEN 30:17 God hear Leah prayer; so e kon get belle and e born anoda boy for Jakob for di fift time.
GEN 30:18 Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.
GEN 30:19 Leah get belle again and e born di nomba six boy.
GEN 30:20 Den Leah sey, “God don give mi betta gift. Naw, my husband go honor mi, bikos I don born six boys for am.” So e kon am Zebulun.
GEN 30:21 Afta, Leah born one girl kon koll am Dinah.
GEN 30:22 Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle.
GEN 30:23 Rashel get belle kon born boy. Den Rashel sey, “God don take my shame komot.”
GEN 30:24 E kon koll am Josef wey mean, “Make God give mi anoda boy pikin.”
GEN 30:25 Afta Rashel don born Josef, Jakob kon tell Laban, “Make yu let mi go house go meet my own pipol for my own kountry.
GEN 30:26 Make I take my wifes and my shidren follow body, bikos I don work for yu.”
GEN 30:27 But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.”
GEN 30:28 Laban still tell Jakob, “Make yu just tell mi wetin I go pay and I go pay yu.”
GEN 30:29 Jakob ansa, “Yu know as I don work for yu and how I don kare for yor animals.
GEN 30:30 True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”
GEN 30:31 So Laban ask, “Wetin yu wont make I give yu?” Jakob ansa, “Yu nor nid to give mi anytin, but if yu gri with dis one tin, I go kontinue to kare and guide yor animals:
GEN 30:32 Make yu let mi waka round all yor animal kon komot di ones wey get spot or mark or wey black. Dis animals go bi my pay.
GEN 30:33 Den my good go tok for mi leta, wen yu go si sey na only di ones wey yu give mi I take. If yu si any animal wey nor get mark, or spot or black, den make yu koll mi tif.”
GEN 30:34 Laban kon sey, “I gri! Make e bi as yu tok.”
GEN 30:35 So dat day, Laban komot all di animals wey get white spot, mark or wey black kon sey make en pikin kare for dem.
GEN 30:36 Den e separate dem from Jakob own with three days journey and Jakob kon dey kare for di oda animals.
GEN 30:37 But Jakob take fresh branches wey dem just kut from poplar, almond and plane tree kon peel dem until e si di white wood for inside.
GEN 30:38 Den e put di tree wood for di wota where di animals for dey drink. E put dem for di animals front wen dem dey chop and dem kon drink di wota.
GEN 30:39 Den wen di sheep dem sleep togeda for di branches front, dem kon dey born pikin wey get mark, spot and black.
GEN 30:40 Jakob kon separate doz animal from Laban own. Den wen di animals won sleep with each oda again, e kon turn dem face Laban own wey nor get spot and black. So e kon get animal for ensef and e nor mix dem with Laban own.
GEN 30:41 Wen di strong animals wey bi woman won sleep with man animal, Jakob go put di branches for wota, so dat dem go sleep togeda near di branches.
GEN 30:42 But if di animals dey weak, e nor go put di branches for dia front. Like dis, na Laban kon get all di weak animals and Jakob kon get di ones wey dey strong.
GEN 30:43 Like dis, Jakob kon get money, animals, both man and woman savant, kamel, donkey and plenty propaty.
GEN 31:1 Jakob kon hear sey, Laban shidren dey sey, “Jakob don take evritin wey bi awa papa own and naw, e don get money well-well.”
GEN 31:2 So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.
GEN 31:3 Den God tell Jakob, “Make yu go back to yor papa and yor family and I go dey with yu.”
GEN 31:4 So Jakob sey make dem koll Rashel and Leah kom meet am for di field
GEN 31:5 and e tell dem, “E klear sey una papa nor like mi again. But di God wey bi my papa God always dey with mi.
GEN 31:6 Una know sey I don serve una papa with all my mind and pawa,
GEN 31:7 yet una papa wont shit and short-pay mi. But God nor gri make una papa wound mi.
GEN 31:8 If una papa sey, ‘Di animals wey get spot go bi yor pay,’ dat mean sey all di animal wey dem born with spot for body go bi my own and if una papa sey, ‘Di one wey get mark go bi yor pay,’ den all di animals wey dem born with mark for dia body, go bi my own too.
GEN 31:9 Like dis, God don give mi many of una papa animals.
GEN 31:10 For di time wen animals dey sleep with each oda, I look kon si for dream sey di goats wey dey sleep with di oda animals, get mark, spot and dem dey black.
GEN 31:11 Den God angel tell mi for di dream, ‘Jakob,’ so I ansa, ‘Na mi bi dis!’
GEN 31:12 Di angel sey, ‘Make yu si and know sey, all di goats wey sleep with di oda animals, get spot, mark and dem black, bikos I don si evritin wey Laban dey do yu.
GEN 31:13 Bikos na mi bi di God wey dey for Bethel, di place where yu for anoint stone kon make vow. Naw, make yu get up komot from dis land, den go back go meet yor pipol.’ ”
GEN 31:14 Den Rashel and Leah ansa, “E still get anytin wey remain for us for awa papa house?
GEN 31:15 E nor dey trit us like strenjas naw? Bikos e don sell us and e don really chop di money.
GEN 31:16 All di money and propaty wey God don take from awa papa hand, na wi and awa shidren get dem.”
GEN 31:17 So Jakob kon put en wife and shidren on-top kamel.
GEN 31:18 E karry all en animals, all en propaty wey e don get, di animals wey e buy for Paddan Aram den e kon dey go Kanaan Land go meet en papa Isaak.
GEN 31:19 As Laban go kare for en sheep, Rashel kon tif en papa gods for di house.
GEN 31:20 Jakob deceive Laban di Aramean, bikos e nor tell dem sey e won go.
GEN 31:21 E go with evritin wey e get. E cross Eufrates River den e kon face di hill kountries for Gilead.
GEN 31:22 Wen dem tell Laban for di third day sey Jakob don run,
GEN 31:23 e take en men with am kon porshu Jakob for seven days. E katch am for di hill kountries for Gilead.
GEN 31:24 But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
GEN 31:25 Laban meet Jakob for where e dey. Naw Jakob don build tent for di hill and Laban and en men still build tent for dat aria too.
GEN 31:26 So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod?
GEN 31:27 Why yu play wayo run kon deceive mi? But yu for tell mi, so dat I go free yu with good mind kon play instrument and sing betta song for yu.
GEN 31:28 Why yu nor allow mi tell my grand-shidren and dotas bye-bye? Si, wetin yu do so, nor dey good at-all.
GEN 31:29 If I won wound yu, I go fit do am. But yor papa God tell mi yestiday nite for dream sey, ‘Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.’
GEN 31:30 And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”
GEN 31:31 Jakob ansa Laban, “Na fear kause am, bikos I tink sey yu go take yor shidren from mi with force.
GEN 31:32 But anybody hand wey yu for si yor gods, go die. For all dis men present make yu point di tin wey I karry wey bi yor own, den make yu take am.” Naw Jakob nor know sey na Rashel tif di gods.
GEN 31:33 So Laban enter Jakob room and Leah room with di two savant own, but e nor si anytin. Den e komot from Leah room kon enter Rashel own.
GEN 31:34 Naw, Rashel don take di gods kon put dem for kamel den e sidan put. Laban look evriwhere for di tent, but e nor si dem.
GEN 31:35 Den Rashel tell en papa, “Make my oga nor vex sey I nor fit stand, bikos I dey si my period.” So e look evriwhere and e nor si di gods.
GEN 31:36 Den Jakob kon dey vex well-well for Laban sey, “Na wetin I do? Na wish sin I kommit wey make yu porshu mi like dis?
GEN 31:37 Yu don shek evritin wey I get; wetin yu don si wey bi yor own? Make yu bring am kom out before my men and yor men, so dat dem go tok put for dis matter.
GEN 31:38 “I don dey with yu for twenty years naw. Yor animals wey get belle dey always born and I neva for one day chop one among yor animals.
GEN 31:39 Anytin wey wiked animal chop, I nor dey bring dem kom meet yu, I dey karry di cross by mysef. Yu dey ask of am from my hand, weda dem tif am for nite or day time.
GEN 31:40 Na der I dey-dey: for day time, di sun dey waya mi and for nite, kold dey won kill mi and sleep dey komot my eyes.
GEN 31:41 For dis twenty years wen I dey for yor house. I serve yu for fourteen years for yor two dotas and six years for di animals, but yu still dey short-pay mi anyhow.
GEN 31:42 If my papa God, Abraham God and di Pesin wey Isaak dey fear nor dey with mi, true-true yu for porshu mi go without anytin. God si my mind and di work wey I dey do with my hand, naim make am tok to yu yestiday nite.”
GEN 31:43 Den Laban ansa Jakob, “Di girls na my pikin, di shidren na my shidren, di animals na my animals and evritin wey yu dey si so, na my own. But wetin go make mi ponish my dotas and di shidren wey dem born?
GEN 31:44 So make yu kom make wi enter agriment; dat is yu and mi. And dat one go show sey wi don setol.”
GEN 31:45 So Jakob take one stone kon set am as pila for der.
GEN 31:46 Den Jakob tell en men, “Make una gada stones.” And dem gada many stones wey high like mountin den dem kon chop for der.
GEN 31:47 Laban koll am Jegar-Sahaduta, but Jakob koll am Galeed.
GEN 31:48 Laban kon sey, “Dis stones na witness between yu and mi today.” Dat na why dem koll am Galeed
GEN 31:49 and Mizpa, bikos e sey, “Make di Oga God dey wosh mi and yu, even wen wi nor dey togeda again.
GEN 31:50 “If yu opress my dotas or if yu marry anoda wife follow my dotas, aldo nobody dey to si us, but God na awa witness.”
GEN 31:51 Den Laban tell Jakob, “Si dis stones and di pila wey wi build between us.
GEN 31:52 Na dem go bi witness and I nor go ever pass di stones kom meet yu and yu too nor go ever pass kom meet mi, bikos yu won kon fight mi.
GEN 31:53 Abraham and Nahor God, dia grand-papa God go judge between yu and mi.” So Jakob kon swear with di God wey en papa Isaak dey fear
GEN 31:54 and Jakob offa sakrifice for di hill kon koll en men kom chop bread. Dem chop bread kon sleep for di hill dat nite.
GEN 31:55 Very early for di next morning, Laban wake-up kon kiss en grand-shidren and en dotas, den e bless dem. Den Laban kon go en house.
GEN 32:1 Jakob kon go en own way and God angels kom meet am.
GEN 32:2 Wen Jakob si dem, e kon sey, “God dey for dis place!” So e name di place Mahanaim.
GEN 32:3 Jakob send message go meet en broda Esau for Seir wey dey for Edom land
GEN 32:4 and e tell dem sey, “Make una tell my oga Esau sey: Dis na wetin yor savant Jakob tok, ‘I don dey stay with Laban since kon rish naw.
GEN 32:5 I get difren animals, man and woman savants. I just sey make I kon tell my oga, so dat e go forgive mi.’ ”
GEN 32:6 Leta, di messenja kom back kon tell Jakob sey, “Wi go meet yor broda Esau and E dey kom meet yu and 400 men dey with am.”
GEN 32:7 Den Jakob kon dey fear and en mind nor setol. E divide both di pipol wey dey with am and di animals into two group,
GEN 32:8 bikos e tink sey, “If Esau kom attack one group, den di oda group for di oda side go run.”
GEN 32:9 Jakob kon sey, “My papa Abraham and Isaak God, di Oga God wey tell mi sey, ‘Make yu go back to yor kountry and yor family, so dat I go do good for yu,’
GEN 32:10 I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
GEN 32:11 Abeg, make Yu save mi from Esau my broda; bikos I dey fear sey e fit kom attack mi, my wifes and my shidren.
GEN 32:12 Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”
GEN 32:13 So Jakob stay der dat nite and from all di tins wey e get, e kon send some present go give en broda Esau.
GEN 32:14 Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,
GEN 32:15 thirty kamel wey get betta milk for breast and dia shidren, forty melu and ten bull, twenty woman donkey and ten man donkey.
GEN 32:16 E pak dem give en savants and dem separate dem, den e sey, “Make una dey go for front and make una make sure sey dem nor join togeda.”
GEN 32:17 E tell di savant wey dey front-front sey, “Wen my broda Esau meet and ask yu sey, ‘Na who bi yor oga? Where yu from dey kom? Who get all dis animal wey yu dey guide?’
GEN 32:18 Den make yu sey, ‘Dem bi yor savant Jakob own. E send dem as gift kon give yu, Esau awa oga. Jakob sef dey kom for awa back.’ ”
GEN 32:19 E still kommand di sekond one with all di oda savants for en front wey dey follow di gifts sey, “All of una must tell my broda Esau di same tin wen una meet am.
GEN 32:20 Una must sey, ‘Yor savant Jakob dey kom for back.’ ” Jakob tink for en mind sey, “I go first beg am with di gifts wey I dey send go for front. Afta dat one, I go meet am, den may bi e go fit forgive mi.”
GEN 32:21 So e send di gifts go for front, while e kon sleep for en kamp dat nite.
GEN 32:22 For nite, Jakob kwik-kwik take en two wife, en two savant and en eleven shidren kon go Jabbok wotaside.
GEN 32:23 E take dem cross di wota with all di tins wey e get.
GEN 32:24 So na only Jakob kon dey. Den en and one man fight till day break.
GEN 32:25 Wen di man si sey e nor fit beat Jakob, e kon shift di bone for Jakob lap komot from where e dey.
GEN 32:26 Den di man sey, “Make yu allow mi dey go, bikos day don dey break.” But Jakob ansa, “I nor go let yu go, unless yu bless mi.”
GEN 32:27 Den di man ask Jakob, “Wetin bi yor name?” Jakob ansa, “My name na Jakob.”
GEN 32:28 Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
GEN 32:29 Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.
GEN 32:30 So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”
GEN 32:31 E nor fit waka well as e dey pass Penuel land, bikos of en lap wey dey pain am, so sun kon dey beat am.
GEN 32:32 Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
GEN 33:1 Jakob look up kon si Esau dey kom with 400 men. So e kon divide di shidren among Leah, Rashel and en two savant.
GEN 33:2 E put di savant and dia shidren for front, den Leah and en shidren, den Rashel and en pikin kon follow for back.
GEN 33:3 But Jakob by ensef kon waka go dia front and e bow face groun seven times as e dey waka near en broda.
GEN 33:4 But Esau run go meet am kon hug and kiss am. Den di two of dem kon dey kry.
GEN 33:5 Wen Esau si di wimen and dia shidren, e kon ask, “Na who bi dis pipol wey dey with yu?” Jakob ansa, “Na di shidren wey God don give mi, yor savant.”
GEN 33:6 Di savants first kom bow with dia shidren for Esau.
GEN 33:7 Den Leah kom with en shidren kon bow, before Rashel and en pikin Josef kon bow for am.
GEN 33:8 Esau kon ask, “Wetin dey yor mind wey make yu send all dis tins kon give mi?” Jakob ansa, “My oga, na make yu for forgive mi.”
GEN 33:9 But Esau sey, “My broda, make yu keep wetin yu get, bikos di ones wey I get plenty rish for mi.”
GEN 33:10 But Jakob sey, “If yu know sey yu don forgive mi, den make yu take all dis gift wey I bring kom give yu. Bikos as I don si yor face and yu don forgive mi, e just bi like sey na God face I dey si.
GEN 33:11 So, abeg, make yu take all dis present wey I bring kon give yu, bikos God dey good to mi and I get evritin wey I wont.” Wen Jakob beg am well-well, e kon take dem.
GEN 33:12 Den Esau kon sey, “Make I dey go! I go dey go for yor front.”
GEN 33:13 Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.
GEN 33:14 So make my oga dey go for en savant front. I go dey kom small-small bikos of di shidren and di animals and I go meet yu for Seir.”
GEN 33:15 So Esau sey, “Make I leave some among my men with yu.” Jakob ansa, “Why yu still won do like dat? My oga, yu don try well-well.”
GEN 33:16 So, dat day, Esau kon go back to Seir.
GEN 33:17 But Jakob travel go Sukkot where e for build house for ensef and en animals. Dat na why dem dey koll dat place Sukkot.
GEN 33:18 Afta e don komot from Paddan Aram, Jakob kon rish Shekem town wey dey for Kanaan and e stay near di town.
GEN 33:19 Den e buy di field where e bin build en tent put; E buy am from Hamor pikin wey bi Shekem papa for one hundred silva.
GEN 33:20 For der, e build one altar kon name am, “Na Israel God bi God.”
GEN 34:1 Dinah wey bi Leah dota wey e born for Jakob go visit di wimen for di land.
GEN 34:2 Hamor wey kom from Hiv, wen e pikin Shekem wey bi di prince for di land si di girl, e seize am kon sleep and disgrace am.
GEN 34:3 Den en mind nor gri komot di girl body again. E love di girl kon dey tok to am well.
GEN 34:4 So Shekem tell en papa Hamor sey, “Make yu help mi get dis girl make e bi my wife.”
GEN 34:5 Naw Jakob hear sey dem don rape and sleep with Dinah en dota. But en boys pikin dey di field with en animals, so Jakob nor tok until dem kom back.
GEN 34:6 So Hamor wey bi Shekem pikin kon meet and tok to Jakob.
GEN 34:7 By dis time, Jakob sons don kom back from di field, but as soon as dem hear wetin happen, dem kon dey vex well-well, bikos wetin e do nor good at-all, bikos dis kind tin nor suppose happen for Israel.
GEN 34:8 But Hamor beg dem sey, “My pikin soul dey una sista hand. Abeg make una give di girl to am as en wife.
GEN 34:9 Make una allow us marry from una. Make una give us una dotas and make una marry awa dotas too.
GEN 34:10 Una go dey stay with us and una fit enter dis land wen ever una wont. Make una stay and sell for here kon get propaty for here too.”
GEN 34:11 Shekem still tok to Jakob and en sons sey, “Make una forgive mi and anytin wey una ask mi, I go give una.
GEN 34:12 Make una ask mi for big bride prize and gifts and I go give una evritin wey una ask for. All I wont na make una give mi una sista as my wife.”
GEN 34:13 Jakob sons ansa Shekem and en papa Hamor with wayo, bikos e don disgrace dia sista, Dinah.
GEN 34:14 Dem sey, “Wi nor fit do dis tin; wi nor fit give awa sista to pesin wey dem neva sekonsaiz, bikos dat go bi disgrace for us.
GEN 34:15 Na only one tin go make us agri with una and dat na if una go gri bi as wi bi and evry man among una go sekonsaiz.
GEN 34:16 Den wi go give una awa sista kon take una own too; wi go stay with una and wi go bi one family.
GEN 34:17 But if una nor go listin to us and nor gri sekonsaiz, den wi go take awa dota and wi go-go.”
GEN 34:18 Dis tin wey dem tok sweet Hamor and en pikin, Shekem.
GEN 34:19 So di yong man nor waste time as e go do di tin wey dem tell am, bikos e love Dinah, wey bi Jakob pikin well-well. True-true, na en dem dey honor pass for en papa house.
GEN 34:20 So Hamor and en pikin Shekem kom di town gate kon tok to all di men for di town sey,
GEN 34:21 “Dis men nor dey look for trobol; make dem stay for awa land kon sell with us, bikos di land big rish for all of us. Make wi marry dia dotas as awa wifes and make wi give dem awa dotas as dia wifes too.
GEN 34:22 But na only for one kondishon di men go agri to stay with us as one family and na sey, evry man among us go sekonsaiz as dem sekonsaiz too.
GEN 34:23 If wi do wetin dem tok, all dia animals and propaty go bi awa own. Make wi just gri with dem and dem go stay with us.”
GEN 34:24 All of dem leave di gate afta dem don listin to Hamor and en pikin Shekem and all di men kon go sekonsaiz, dat is all of dem wey kom di town gate.
GEN 34:25 So for di third day, wen all of dem still get sore, two among Jakob sons, Simeon and Levi, Dinah brodas, take swod go fight di town kon kill all di men.
GEN 34:26 Dem kill Hamor and en pikin Shekem with di swod, take Dinah komot from Shekem house, den dem kon go.
GEN 34:27 Jakob sons kom di town where dem for kill all di men kon pak dia propaty and skata di town, bikos dem don disgrace and rape dia sista.
GEN 34:28 Dem take dia animals and all di propaty wey dey di town and di field.
GEN 34:29 All dia propaty, dia shidren and dia wifes, dem katch dem kon skata der.
GEN 34:30 Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”
GEN 34:31 But dem sey, “So e good as e trit awa sista like ashawo?”
GEN 35:1 Den God tell Jakob, “Make yu go Bethel go stay. Make yu build one altar for God for where E for appear to yu wen yu dey run from Esau yor broda.”
GEN 35:2 So Jakob tell en hold family and doz wey dey with am sey, “Make una skata all di oda gods wey dey with una. Make una go wosh unasef kon shange una klot.
GEN 35:3 Naw, make wi dey go Bethel. Den I go build altar for God wey dey ansa mi wen I dey trobol and E always dey with mi for anywhere wey I dey go.”
GEN 35:4 So dem give Jakob all di oda gods wey dey with dem and di rings wey dey dia ears. Jakob beri dem under one oak tree near Shekem
GEN 35:5 and dem kon start dia journey. Di towns wey dey dat aria dey fear God and fear nor gri let dem porshu Jakob and en shidren.
GEN 35:6 Jakob and all di pipol wey dey with am kon rish Luz (wey bi Bethel naw) wey dey Kanaan land.
GEN 35:7 E build one altar for der kon koll am El Bethel (wey mean God house), bikos na for der God for show ensef to am wen e dey run from en broda.
GEN 35:8 (Deborah wey bi Rebekah nurse kon die and dem beri am under di oak tree for Bethel; so dem kon koll di place “Oak wey dem for dey kry.”)
GEN 35:9 Afta Jakob kom back from Paddan Aram, God appear to am again kon bless am.
GEN 35:10 God tell am, “Yor name na Jakob, but pipol nor go koll yu Jakob again; na Israel dem go dey koll yu.” So, God koll am Israel.
GEN 35:11 Den God tell am, “Na mi bi di God wey get pawa. Yu go dey fruitful and yor propaty go plenty! One nashon; even many nashon go kom from yu and kings go dey join yor shidren-shidren!
GEN 35:12 Di land wey I give Abraham and Isaak, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.”
GEN 35:13 Den God leave am for di place where E for dey tok to am.
GEN 35:14 So Jakob arrange some stone for di place where God for tok to am. E kon use drink take do ofrin for God, den e pour oil put.
GEN 35:15 Jakob kon koll di place where God for tok to am Bethel.
GEN 35:16 Dem travel from Bethel go Efrat wey far from der small. Rashel kon dey labor and di belle dey pain am well-well.
GEN 35:17 Wen di labor don strong well-well, di pesin wey won help am born kon tell am, “Make yu nor fear, bikos na anoda boy yu won born.”
GEN 35:18 As Rashel dey breath like who won die, e kon koll di pikin Ben Oni. But Israel koll am Benjamin.
GEN 35:19 So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).
GEN 35:20 Jakob put one mark on-top di grave, so dem dey koll di place Rashel Grave kon rish today.
GEN 35:21 Den Israel kontinue en journey kon go stay for Migdal Eder.
GEN 35:22 As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:
GEN 35:23 Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.
GEN 35:24 Di sons wey Rashel born na Josef and Benjamin.
GEN 35:25 Di sons wey Bilhah, Rashel savant born na Dan and Naftali.
GEN 35:26 Di sons wey Zilpah, Leah savant born na Gad and Asher. All dis na Jakob sons wey dem born for am for Paddan Aram.
GEN 35:27 So Jakob kom back kon meet en papa Isaak for Mamre, wey dey Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw), di place where Abraham and Isaak stay.
GEN 35:28 Isaak stay for one hundred and eighty years.
GEN 35:29 Den Isaak kon die go join en grand-grand papa dem. E old well-well before e die and e live en life komplete. En sons Esau and Jakob kon go beri am.
GEN 36:1 Dis na di shidren wey Esau (wey bi Edom) born.
GEN 36:2 Esau marry from Kanaan and di woman name na Adah and na Elon wey kom from Hit bi en papa. E still marry Oholibama, wey bi Anah pikin and na Zibeon wey kom from Hiv, na en grand-papa.
GEN 36:3 E still marry Basemat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael bi dia papa.
GEN 36:4 Adah born Elifaz for Esau and Basemat born Reuel.
GEN 36:5 Oholibama born Jeush, Jalam and Korah. All dis na Esau sons wey dem born for Kanaan.
GEN 36:6 Esau take en wifes, en shidren, evribody wey dey with am and en animals and evritin wey e get wey e buy from Kanaan kon go anoda land wey nor dey near en broda Jakob,
GEN 36:7 bikos dia propaty too many and dem nor fit stay togeda, bikos di land wey dem dey, nor big rish.
GEN 36:8 So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.
GEN 36:9 Dis story na about Esau, Edom pipol papa for di hill aria wey dey Seir.
GEN 36:10 Dis na Esau sons name: Elifaz wey Esau wife Adah born; Reuel wey Esau wife Basemat, born.
GEN 36:11 Elifaz sons na: Teman, Omar, Zefo, Gatam and Kenaz.
GEN 36:12 Elifaz wey bi Esau pikin, en girl-friend Timna kon born Amalek for am. Dis na di sons wey Esau wife Adah, born.
GEN 36:13 Reuel sons na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah. Na Esau wife Basemat born dis shidren.
GEN 36:14 Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin and Zibeon grand-pikin, na di sons wey e born for Esau bi dis: Jeush, Jalam and Korah.
GEN 36:15 Di shiefs among Esau shidren; among en first-born Elifaz sons na: shief Teman, shief Omar, shief Zefo, shief Kenaz,
GEN 36:16 shief Korah, shief Gatam and shief Amalek. Dis na di shiefs wey kom from Elifaz for Edom land and dem bi Adah sons.
GEN 36:17 Reuel wey Esau born, na en sons bi dis: shief Nahat, shief Zera, shief Shammah and shief Mizzah. All dis na di shiefs wey kom from Reuel for Edom land and dem bi Basemat sons.
GEN 36:18 Dis na di sons wey Esau wife Oholibama born: shief Jeush, shief Jalam and shief Korah. Na Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin, born all dis shiefs.
GEN 36:19 All dis na Esau (wey bi Edom) sons and dia shiefs.
GEN 36:20 Seir wey kom from Horite na en sons for di land bi dis: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah,
GEN 36:21 Dishon, Ezer and Dishan. Dis na di shiefs from Horite wey bi Seir shidren-shidren for Edom land.
GEN 36:22 Lotan sons na Hori and Homam; Lotan sista na Timna.
GEN 36:23 Dis na Shobal sons: Alvan, Manahat, Ebal, Shefo and Onam.
GEN 36:24 Na Zibeon sons bi dis: Aiaya and Anah (wey si di hot spring for di wildaness as e dey guide di animals wey bi en papa Zibeon own).
GEN 36:25 Anah shidren na: Dishon and Oholibama wey bi Anah dota.
GEN 36:26 Na Dishon sons bi dis: Hemdan, Eshban, Itran and Keran.
GEN 36:27 Ezer sons na: Bilhan, Zaavan and Akan.
GEN 36:28 Dishan sons na: Uz and Aran.
GEN 36:29 Di shiefs for Horite na: shief Lotan, shief Shobal, shief Zibeon, shief Anah,
GEN 36:30 shief Dishon, shief Ezer and shief Dishan. All dis na di shiefs for Horite akordin to di shief list for Seir land.
GEN 36:31 Dis na di kings wey rule for Edom land before any king rule for Israel:
GEN 36:32 Beor pikin Bela, rule for Edom; di town name na Dinhabah.
GEN 36:33 Wen Bela die, Jobab wey bi Zera wey kom form Bozrah kon rule for der.
GEN 36:34 Wen Jobab die, Husham wey kom from Teman kon rule for der.
GEN 36:35 Wen Husham die, Hadad wey bi Bedad pikin kon win Midian pipol for Moab land, den e rule for der. Di town name na Avit.
GEN 36:36 Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon rule for der.
GEN 36:37 Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon rule too.
GEN 36:38 Wen Shaul die, Baal-Hanan wey bi Akbor son kon rule for der.
GEN 36:39 Wen Akbor pikin, Baal-Hanan die, Hadad kon rule for der; di town name na Pau. En wife name na Mehetabel wey bi Matred dota and Matred na Me-Zahab dota too.
GEN 36:40 Dis na di shiefs name for Esau family, akordin to dia family, place and dia names. Dem bi: shief Timna, shief Alvah, shief Jetet,
GEN 36:41 shief Oholibama, shief Elah, shief Pinon,
GEN 36:42 shief Kenaz, shief Teman, shief Mibzar,
GEN 36:43 shief Magdiel and shief Iram. All dis na di shiefs for Edom, akordin to where dem stay for di land wey dem kollect. Esau wey bi Edom pipol papa, na en story bi dis.
GEN 37:1 Jakob kon go stay for di land where en papa bin stay for Kanaan.
GEN 37:2 Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem.
GEN 37:3 Israel love Josef pass all en sons, bikos e don old before dem born am, so e kon make one special koat for am.
GEN 37:4 Wen Josef brodas si sey dia papa like am pass dem, dem kon hate Josef and dey tok to am anyhow.
GEN 37:5 Josef dream and wen e tell en brodas about wetin e dream, dem kon hate am more-more.
GEN 37:6 E tell dem sey, “Make una listin to my dream:
GEN 37:7 E get many korn for di field centre. At wons my korn stand up for di centre and una korn kon bow down for am!”
GEN 37:8 Den en brodas ask am, “So yu really tink sey yu go rule ova us or get pawa pass us?” So dem kon hate am more-more, bikos of di dream and wetin e tok.
GEN 37:9 Den, Josef dream anoda dream kon tell en brodas. “Make una si, I dream anoda dream. For dis dream, di sun, di moon and eleven stars kon bow down for mi.”
GEN 37:10 Wen e tell en papa and en brodas, en papa shaut for am kon sey, “Wetin bi dis dream wey yu dey dream? So mi, yor mama and all yor brodas go really kom bow down for yu?”
GEN 37:11 Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.
GEN 37:12 Wen en brodas don go find food for dia papa animals near Shekem,
GEN 37:13 Israel kon tell Josef, “Yor brodas dey for di field near Shekem. Make yu kom make I send yu go meet dem.” Josef ansa, “Papa! I don ready.”
GEN 37:14 So Jakob tell am, “Make yu go si as yor brodas and di animals dey, den kon tell mi weda dem dey okay.” So Jakob send am go from Hebron Valley.
GEN 37:15 Wen Josef rish Shekem, one man kon si am dey waka anyhow for di field, so di man ask am, “Na wetin yu dey find?”
GEN 37:16 Josef ansa, “I dey find my brodas. Abeg make yu tell mi where dem and di animals dey.”
GEN 37:17 Di man kon sey, “Dem don komot dis aria, bikos I hear wen dem dey sey, ‘Make wi go Dotan.’ ” So Josef find en brodas go Dotan.
GEN 37:18 Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.
GEN 37:19 Dem tell each oda, “Si di oga wey sabi dream dey kom!
GEN 37:20 Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”
GEN 37:21 Wen Reuben hear wetin dem tok, e kon save Josef from dia hand wen e sey, “Make wi nor kill-am!”
GEN 37:22 Reuben still sey, “Make wi nor put blood for awa head! So make wi trow am for gutta for here inside dis wildaness, but make una nor tosh am at-all.” (Reuben tok like dis so dat leta, e go-go save Josef give en papa.)
GEN 37:23 Wen Josef rish where en brodas dey, dem komot en fine koat for en body, di one wey e papa make for am.
GEN 37:24 Den dem take am kon trow am put for one deep gutta. (Di gutta dey empty; wota nor dey inside.)
GEN 37:25 Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
GEN 37:26 Den Judah kon tell en brodas, “Wetin wi go gain if wi kill awa own broda kon kover en blood?
GEN 37:27 So make wi sell am give dis Ishmael pipol, but make wi nor kill-am, bikos e still bi awa broda; awa flesh and blood.” En brodas kon agri with wetin e tok.
GEN 37:28 So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.
GEN 37:29 Leta, wen Reuben go back to di gutta, e kon si sey Josef nor dey der again! E tear en klot
GEN 37:30 kon go meet en brodas sey, “Josef nor dey der again! So naw, where I won find am go?”
GEN 37:31 So dem take Josef koat kon kill one small goat, den soak am inside di blood.
GEN 37:32 Dem take di koat go give Jakob sey, “Dis na wetin wi si. Make yu look am well weda na yor pikin Josef own or not.”
GEN 37:33 Jakob look am well kon sey, “Na my pikin own! One wiked animal don chop am! So, Josef don really die for wiked animal hand?”
GEN 37:34 Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.
GEN 37:35 All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
GEN 37:36 Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.
GEN 38:1 For dat time, Judah leave en brodas kon go stay with one man wey kom from Adullam and en name na Hirah.
GEN 38:2 For der, Judah si one girl wey kom from Kanaan and en papa name na Shua. Judah marry and sleep with am.
GEN 38:3 Di girl get belle kon born boy and Judah koll am Er.
GEN 38:4 Di woman get belle again kon born anoda boy and en mama koll am Onan.
GEN 38:5 Den e kon born anoda boy and e koll am, Shelah and e born dis one for di town wey dem dey koll Kezib.
GEN 38:6 Judah kon marry wife give Er en first-born and di woman name na Tamar.
GEN 38:7 But Er, Judah first-born kon sin against God, so God kon kill-am.
GEN 38:8 Den Judah tell Onan en pikin, “Make yu sleep with yor broda wife, make e for fit born for yor broda.”
GEN 38:9 But Onan know sey di pikin nor go bi en own. So wen ever e dey sleep with en broda wife, e dey kwik get up, so dat e nor go born shidren for en broda wey don die.
GEN 38:10 So wetin E do kon make God vex, so God kon kill-am too.
GEN 38:11 So Judah kon tell en pikin wife Tamar sey, “Make yu go stay for yor papa house as woman wey en husband die until my pikin Shelah go grow rish to marry yu.” Bikos e tink for en mind sey, “I nor wont make Shelah die like en brodas.” So Tamar kon go stay for en papa house.
GEN 38:12 Afta sometaim, Judah wife wey bi Shua pikin kon die. Afta Judah don mourn for am, e kon go Timnah go visit doz wey dey barb sheep hair with en friend Hirah wey kom from Adullam.
GEN 38:13 Dem kon tell Tamar sey, “Si, yor husband papa dey go Timnah go barb sheep hair.”
GEN 38:14 So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.)
GEN 38:15 Wen Judah si am, e tink sey na ashawo, bikos e kover en face.
GEN 38:16 So e turn face am for di road kon sey, “Make yu kom! I like sleep with yu.” (Judah nor know sey na en pikin wife.) Di woman ansa, “Na wetin yu go give mi afta yu don sleep with mi?”
GEN 38:17 Judah ansa, “I go give yu one small goat from my animals.” Di woman ansa, “Wetin yu go give mi, make I for know sey yu go send di goat kom?”
GEN 38:18 Judah sey, “Na wetin yu wont make I give yu?” Di woman ansa, “Make yu give mi yor seal, waist belt and di rod wey dey yor hand.” So Judah give dem to am kon sleep with am. So Tamar kon get belle for Judah.
GEN 38:19 Di woman komot for der at wons, remove di klot kon wear di klot wey show sey e dey mourn.
GEN 38:20 Den Judah kon give en friend Hirah from Adullam one yong goat make e go give di woman, so dat e go gi-am back all di tin wey e gi-am before, but wen Hirah rish der, e nor si am again.
GEN 38:21 E ask di men wey dey der sey, “Where di ashawo wey dey here for Enaim road?” Dem ansa am, “Wi neva si any ashawo for here before.”
GEN 38:22 So Hirah go back go tell Judah, “I nor si di ashawo for der. And di men for di place sey, ‘Dem neva ever si ashawo for der before.’ ”
GEN 38:23 Judah kon sey, “Make di ashawo keep doz tins for ensef. If not e go bi like sey wi nor bi betta pipol. I really send di yong goat go, but wi nor si am.”
GEN 38:24 Afta three monts, dem kon tell Judah sey, “Yor pikin wife Tamar don turn to ashawo and e don get belle.” Judah kon sey, “Make una go bring Tamar kom make dem burn am!”
GEN 38:25 As dem dey bring am kom out, e kon sey make dem go tell en husband papa sey, “Na di man wey get dis tins give mi belle.” Den di woman sey, “Make yu find di pesin wey get dis seal, waist belt and rod.”
GEN 38:26 Judah know sey di tins na en own so e sey, “Dis woman even dey good and raitious pass mi, bikos I nor gri gi-am to Shelah my son.” So Judah nor gri sleep with am again.
GEN 38:27 Wen time rish for Tamar to born, na twins e born.
GEN 38:28 Wen e dey born, one pikin bring en hand kom out, so di nurse tie dat hand with rope kon sey, “Na dis one first kom out.”
GEN 38:29 But di pikin take en hand go inside back and en broda kon kom out before am. Tamar sey, “Si as yu take kom out from my belle!” So e koll di pikin, Perez.
GEN 38:30 Leta en broda kom out with di rope for en hand, so e koll am Zera.
GEN 39:1 Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.
GEN 39:2 God dey with Josef and evritin dey betta for am, even as e dey for en Egypt oga house.
GEN 39:3 En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.
GEN 39:4 Potifa kon like Josef well-well as Josef dey serve am, so e make am oga ova all di savants for en house and evritin wey e get.
GEN 39:5 From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.
GEN 39:6 So Potifa leave evritin wey e get for Josef make e kare for dem. So di only tin wey koncern Potifa for di house, na to chop. Josef fine well-well and e get betta karata.
GEN 39:7 Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.”
GEN 39:8 But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get.
GEN 39:9 Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
GEN 39:10 As di woman dey tok to Josef evriday sey make e sleep with am or stay small with am, Josef nor dey listin to am.
GEN 39:11 But one day wen Josef enter inside di house go do en work and all di oda savants nor dey inside di house,
GEN 39:12 di woman kon hold en klot dey sey, “Make yu sleep with mi.” But e run komot di house kon leave en klot for di woman hand.
GEN 39:13 Wen di woman si sey Josef don leave en klot for en hand run komot from di house,
GEN 39:14 e kon koll di men for di house dey sey, “Si, my husband don bring one Hibru pesin make e kom take us do yeye. Josef won kon sleep with mi naim I shaut well-well.
GEN 39:15 As Josef know sey I dey shaut and kry, e kon run komot di house, but e forget sey en klot dey near mi.”
GEN 39:16 So di woman keep di klot until en husband kom,
GEN 39:17 den e tell am di same story sey, “Di Hibru savant wey yu bring kom dis house, waka enter my room won kon take mi do yeye.
GEN 39:18 But as soon as I bigin shaut dey kry, e kon run komot di house and e leave en klot.”
GEN 39:19 As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef.
GEN 39:20 So Josef oga karry Josef go put for prison. Na only pipol wey di king arrest dey-dey for di prison where dem karry Josef go.
GEN 39:21 But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too.
GEN 39:22 So di pesin wey dey guide di prison put all di prisonas for Josef kare. Na Josef bi oga for evritin wey dem dey do.
GEN 39:23 Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.
GEN 40:1 Afta all dis tins don happen, di pesin wey dey serve wine for Egypt king and di pesin wey dey bake en bread kon make am vex.
GEN 40:2 Fero wey bi king, vex well-well for en two ofisas
GEN 40:3 so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too.
GEN 40:4 Di oga for di guards kon choose Josef as di pesin wey go dey serve di two ofisas for prison. Dem stay for prison tey small.
GEN 40:5 One day, di two of dem; both di pesin wey dey serve wine and di baker for Egypt wey dey prison kon dream. Each of dem dream get en own meaning.
GEN 40:6 Wen Josef meet dem for morning, e si sey dia face nor dey okay.
GEN 40:7 So e ask Fero ofisas wey dey prison with am for en masta house, “Wetin make una face bi like dis today?”
GEN 40:8 Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.” Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”
GEN 40:9 So di one wey dey serve wine kon tell Josef en dream: “Inside my dream, e get one vine for my front.
GEN 40:10 Di vine get tree branches. Di vine kon dey grow dey fine and e kon dey produce ripe-ripe grape.
GEN 40:11 Fero cup dey my hand, so I take di grape kon press am put for di cup den give di cup to Fero.”
GEN 40:12 Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days.
GEN 40:13 For three days time, Fero go karry yu go back to yor ofis and yu go dey serve wine for Fero as yu dey do before.
GEN 40:14 But make yu remember mi wen evritin dey okay with yu and make yu menshon mi to Fero wen di time rish, so dat I go komot from dis prison.
GEN 40:15 Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”
GEN 40:16 Wen di man wey dey bake bread si sey di meaning dey good, e kon tell Josef, “I still dream too: three kake basket dey my head,
GEN 40:17 and for di one wey dey top, difren kind food wey dem bake for Fero dey inside, but di birds dey chop am from di basket wey dey my head.”
GEN 40:18 So Josef ansa, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three basket na three days.
GEN 40:19 For three days time, Fero go sey make dem hang yu for tree. Den birds go kom chop yor flesh.”
GEN 40:20 So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.
GEN 40:21 Di one wey dey serve wine, Fero gi-am en work back.
GEN 40:22 But e hang di baker, just as Josef tell dem before.
GEN 40:23 But di man wey dey serve wine nor remember Josef again and e kon forget am.
GEN 41:1 Afta two years, Fero kon dream. As e stand near River Nile,
GEN 41:2 e kon si seven melu wey fat and fine well-well dey kom out from di river go chop for di field.
GEN 41:3 Den e si seven melu wey dirty and tin dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones.
GEN 41:4 Den, di tin melu kon swallow di seven fine and fat melu and Fero kon wake-up.
GEN 41:5 Den e sleep again kon dream anoda dream: E si seven korn head dey grow for one korn stik and dem dey fine and big well-well.
GEN 41:6 Den e still si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small and dem dey grow kom out too.
GEN 41:7 Di seven tin korn kon swallow di seven fat and fine ones. Den Fero wake-up kon si sey na dream e dey dream.
GEN 41:8 For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean.
GEN 41:9 Den di man wey dey serve wine for Fero kon tell am, “Na today I know sey I don sin.
GEN 41:10 I remember wen Fero vex for mi en savants kon put mi for prison for di bodyguards oga house; both mi and di shief baker.
GEN 41:11 Wi two dream difren dream for di same nite and di dream get dia own meaning.
GEN 41:12 Naw e get one yong Hibru man for der and e bi di guide oga savant. Wi tell am wetin wi dream and e tell di two of us wetin awa difren dreams mean.
GEN 41:13 Evritin happen just as e tell us. Fero give mi my work back kon hang di shief baker.”
GEN 41:14 Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero.
GEN 41:15 Fero kon tell Josef, “I dream one kind dream and e nor get anybody wey fit tell mi wetin di dream mean. But I don hear about yu sey yu dey fit tell pipol wetin dia dream mean.”
GEN 41:16 Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”
GEN 41:17 Den Fero tell Josef, “I dream sey I stand near Nile river.
GEN 41:18 Den I si seven melu wey fine well-well dey kom out from di river go chop for di field.
GEN 41:19 Den I still si seven dirty and tin melu dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones. I neva si dat kind dirty and tin melu before.
GEN 41:20 Di dirty melu kon swallow di fine ones.
GEN 41:21 Wen dem don chop di fat ones finish, nobody go know sey dem chop anytin, bikos dem still tin as dem bi. Den I kon wake-up.
GEN 41:22 “I still dream si seven korn head dey grow for one korn stik and dem fine and big well-well.
GEN 41:23 Den I si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small dey grow kom out too.
GEN 41:24 Di tin ones kon swallow di fat ones. So I tell all my priest and majishan, but nobody fit tell mi wetin di dreams mean.”
GEN 41:25 Den Josef tell Fero, “Di two dream wey Fero dream get di same meaning. God don show Fero wetin E wont do.
GEN 41:26 Di seven fat melu na seven years and di seven good korn na seven years too. Di two dreams get di same meaning.
GEN 41:27 Di seven tin melu wey kom afta di fat ones na still seven years and di bad korn wey still kom afta di good ones, na seven years wen honga go dey.
GEN 41:28 Dis na wetin I go tell Fero: God don show Fero wetin E won do.
GEN 41:29 Seven years dey kom wen good tins go happen for Egypt.
GEN 41:30 But afta dat seven years, anoda seven years wey honga go dey evriwhere dey kom and evribody go forget di first seven years. Di honga go konfuse di land.
GEN 41:31 Pipol nor go remember di tins wey di land get before, bikos di honga go strong well-well.
GEN 41:32 God show Fero di dream two times, bikos na as God wont make e bi, bi dat and God go soon make am happen.
GEN 41:33 “So make Fero fine one man wey good and get sense kon make am oga ova di land for Egypt.
GEN 41:34 Den make Fero choose one pesin wey go supavise di whole land for Egypt, so dat if dem divide all di tins for Egypt into ten, dem go kollect five part keep for di time wen evritin dey good.
GEN 41:35 For dis good years wey dey kom, make dem gada all di food wey remain. And make Fero kommand dem to keep korn and oda tins, so dat di town go get food and dem go dey keep dem.
GEN 41:36 Make dem keep all dis food for di land until di seven years wey honga go dey, go start. Like dis, di land go fit survive di honga.”
GEN 41:37 Dis advise dey good for Fero ear and all en ofisas.
GEN 41:38 So Fero kon ask en ofisas, “Wi go fit si anoda pesin wey bi like Josef, pesin wey God Spirit dey with?”
GEN 41:39 So Fero tell Josef, “Bikos God don make yu know all dis tins, e nor get anybody wey wise and good like yu!
GEN 41:40 Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”
GEN 41:41 Fero kon tell Josef, “Si! I don put yu as oga ova evribody for Egypt.”
GEN 41:42 Den Fero take en own ring from en hand kon wear am for Josef own. E wear en fine klot for Josef kon put gold shain for en neck.
GEN 41:43 Fero gi-am di shariot wey di pesin afta di king dey ride and e sey, “Make una knee down for am!” So Fero make am oga ova all di land for Egypt.
GEN 41:44 Fero still tell Josef, “Na mi bi Fero, but unless yu sey so, nobody go ever fit enter Egypt.”
GEN 41:45 Fero kon koll Josef, Zafenat-Paneah. E still gi-am Asenat wey bi Potifara dota, priest for On, so dat di woman go bi Josef wife. So Josef kon dey kontrol di whole Egypt.
GEN 41:46 For dis time, Josef na thirty years wen e start to serve Fero and dey kommand evribody for Egypt. Na Fero make Josef oga for di whole Egypt.
GEN 41:47 For di seven years wey food dey, wetin di land produce kon many well-well.
GEN 41:48 Josef take all di food wey remain for Egypt for dat seven years kon keep dem for di main towns. Josef keep food wey dem gada for all di towns.
GEN 41:49 Di korn and rice wey Josef keep, many well-well like san-san wey dey near sea and e nor fit measure dem again, bikos dem too plenty.
GEN 41:50 Asenat, Priest Potifara for On pikin, wey bi Josef wife, born two sons for Josef before di honga start.
GEN 41:51 Josef koll di first-born Manasseh kon sey, “True-true, God don make mi forget all my wahala and my papa house,”
GEN 41:52 E koll di sekond boy, Efraim bikos e sey, “True-true, for di land where I for dey sofa, God don make mi fruitful.”
GEN 41:53 Den di seven years wen tins good for Egypt kon finish.
GEN 41:54 And di seven years for honga kon start just as Josef tok sey e go bi. Honga dey for di whole world, but food dey for Egypt.
GEN 41:55 Wen evribody for Egypt don dey sofa, bikos of di honga, di pipol kon kry go meet Fero make e give dem food. But Fero tell dem, “Make una go meet Josef and anytin wey e tell una, make una do am.”
GEN 41:56 As di honga dey evriwhere for di world, Josef kon open di store where e keep food put kon dey sell food give Egypt pipol. Di honga for di whole Egypt strong well-well.
GEN 41:57 Pipol from evry kountry dey kom buy food from Josef for Egypt, bikos di honga strong well-well.
GEN 42:1 Wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon tell en sons, “Wetin make una dey look each oda?”
GEN 42:2 E sey, “Si, I hear sey food dey for Egypt. Make una go der go buy food, so dat honga nor go kill us.”
GEN 42:3 So ten among Josef brodas kon go Egypt go buy food.
GEN 42:4 But Jakob nor gri allow Benjamin, Josef broda follow dem, bikos e sey, “I nor wont make anytin happen to am.”
GEN 42:5 So Israel shidren follow di oda pipol kon buy food for Egypt, bikos di honga strong well-well for Kanaan land.
GEN 42:6 For dis time, na Josef dey rule di kountry and naim dey sell food give all di pipol. Wen en brodas kom meet am, dem bow face groun.
GEN 42:7 Wen Josef si en brodas, na wons e know dem, but e do like sey e nor know dem kon dey shaut for dem. E ask dem, “Na where una from kom?” Dem ansa, “Na from Kanaan land wi from kom buy food.”
GEN 42:8 Josef know en brodas, but dem nor know am.
GEN 42:9 Den Josef remember di dream wey e dream about dem, so e tell dem, “Una bi tif! Una kon look weda una fit attack awa land!”
GEN 42:10 But dem ansa, “No o-o! My oga, na food yor savants just kom buy o-o!
GEN 42:11 Na one papa all of us get o-o; wi bi good pipol o-o! Abeg, yor savants nor bi tif at-all.”
GEN 42:12 But Josef sey, “Na lie, una kon si if una go fit attack awa land.”
GEN 42:13 En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”
GEN 42:14 But Josef sey, “Just as I tell una before, na tif una bi!
GEN 42:15 Na so I go take test una: As long as Fero dey alive, una nor go komot here until una bring una yonga broda kom here.
GEN 42:16 One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”
GEN 42:17 Josef keep dem for prison for three days.
GEN 42:18 For di third day, Josef kon tell dem, “Make una do as I tok and una go dey alive, bikos I dey fear God.
GEN 42:19 If una really dey good, make una leave one among una broda for here, so dat una go fit take food go give una family wey dey hongry for Kanaan.
GEN 42:20 But una must bring una yonga broda kom meet mi. Den I go bilive una and una nor go die.” So Josef brodas do as e tok.
GEN 42:21 Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”
GEN 42:22 Reuben kon tell dem, “I nor tell una sey make una nor sin against di boy, but una nor gri listin to mi? So naw, wi must pay for di sin wey wi kommit!”
GEN 42:23 (Naw, dem nor know sey Josef dey undastand wetin dem dey tok, bikos e dey speak Egypt language and anoda pesin dey interpret am give en brodas.)
GEN 42:24 So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.
GEN 42:25 Den Josef orda sey make dem put food for dia bag kon put evribody money for dia bag back kon sey make dem help dem for dia journey. So en ofisas do as e tok.
GEN 42:26 So dem kon put dia food for dia donkey kon go.
GEN 42:27 Wen dem dey rest, one among dem open en sak make e give en donkey food and e kon si en money inside di sak.
GEN 42:28 Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”
GEN 42:29 Dem go back go meet dia papa Jakob for Kanaan kon tell am evritin wey happen dey sey,
GEN 42:30 “Di man wey bi di oga for Egypt tok to us bad kon trit us like sey wi bi tif.
GEN 42:31 But wi tell am sey, ‘Wi bi good pipol; wi nor kon spy or tif!
GEN 42:32 Wi bi twelf brodas from one family and na one man born all of us. One don die and as wi dey tok, di yonga one dey with awa papa for Kanaan.’
GEN 42:33 Den di man wey bi di oga for di land kon tell us, ‘Na like dis I go take know if una dey good as una tok. Make una leave one among una brodas for here kon take food go give una family wey dey hongry for Kanaan.
GEN 42:34 But una must bring una yonga broda kon meet mi, so dat I go know sey una dey good and una nor bi tif. Den I go give una broda back to una and una go fit waka as una like for dis land.’ ”
GEN 42:35 As dem dey remove di food from dia sak, all of dem kon si dia money inside dia sak! As dem with dia papa si di money, dem kon dey fear.
GEN 42:36 So dia papa Jakob kon tell dem, “Una won turn mi to who nor get pikin? Josef don die. I nor know wetin dey happen to Simeon naw. And naw una won kollect Benjamin too! Evritin just dey against mi.”
GEN 42:37 Den Reuben tell en papa, “Make yu kill my two sons, if I nor bring Benjamin kom back kom meet yu. Make yu put am for my hand and I go bring am back.”
GEN 42:38 But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”
GEN 43:1 Naw di honga strong well-well.
GEN 43:2 So wen dem don chop di food wey dem buy from Egypt finish, dia papa kon tell dem, “Make una still go back go buy some food kom.”
GEN 43:3 But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’
GEN 43:4 But if yu allow awa broda follow us, den wi go-go buy food.
GEN 43:5 But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”
GEN 43:6 So Israel sey, “Wetin make una kause dis wahala wen una tell di man sey una get anoda broda?”
GEN 43:7 Dem ansa, “Di man ask us kweshon well-well about wi and awa family sey, ‘Una papa still dey alive? Una get anoda broda? So wi ansa am like dat.’ How wi won take know sey e go sey, ‘Make una bring una broda kom’?”
GEN 43:8 Den Judah tell en papa Israel sey, “Make yu allow di boy follow mi and wi go-go togeda. Den wi go dey alive and wi nor go die, both wi, yu and awa shidren.
GEN 43:9 Mi mysef dey swear sey e go dey save; make yu hold mi if e nor kom back.
GEN 43:10 And if nor bi all dis story, wi for don go der kom back like two times naw!”
GEN 43:11 Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.
GEN 43:12 Make una take many money follow body; una must return dat money wey una si for una bag, bikos e if bi sey dem dey try una.
GEN 43:13 Naw, make una karry Benjamin una broda and make una dey go.
GEN 43:14 Make di God wey get pawa give una mesi for di man front, so dat e go release Simeon and Benjamin! But for mi, if I luz my shidren, I luz dem bi dat.”
GEN 43:15 So dem take di gift, karry doubol money kon take Benjamin follow body. Den dem rush go Egypt kon stand for Josef front.
GEN 43:16 Wen Josef si Benjamin with dem, e kon tell en savant wey dey kare for en house, “Make yu take dis men go my house, den make yu kill one animal kon kook am, bikos dis men go chop with mi dis aftanoon.”
GEN 43:17 Di man do just as Josef tell am; e take di men go Josef house.
GEN 43:18 But di men kon dey fear wen dem take dem enter Josef house. Dem kon sey, “Dem bring us kom here, bikos of dat money wey wi si for awa sak dat time. E won katch us, turn us to en slave kon take awa donkey!”
GEN 43:19 So dem go meet di man wey dey kare for Josef house kon follow am tok for di door-mot.
GEN 43:20 Dem tell am, “My oga, wi really kon buy food di first time.
GEN 43:21 But wen wi rish where wi won for sleep dat nite, wi open awa sak and all of us si awa money; dat is di whole money for inside di sak. So wi don riton am.
GEN 43:22 Wi still bring xtra money wey wi go take buy food. Wi nor know who put di money dem for awa sak!”
GEN 43:23 Di man kon tell Josef brodas sey, “Make una nor fear, evritin dey okay. Una God and una papa God don give una gift for una sak. Na mi put di money.” Den e bring Simeon kom out from prison.
GEN 43:24 Di man kon take dem enter Josef house. E give dem wota and dem kon wosh dia legs. Den e give dia donkey food chop.
GEN 43:25 Josef brodas kon keep dia gifts dey wait make Josef kom for aftanoon, bikos dem don tell dem sey dem won chop with am.
GEN 43:26 Wen Josef enter di house, dem kon gi-am dia gift and dem bow face groun for en front.
GEN 43:27 E ask dem how dem dey. Den e sey, “Una papa dey okay, di one wey una tok about? E still dey alive?”
GEN 43:28 Dem kon ansa, “Yor savant wey bi awa papa dey okay and e still dey alive.” Den dem bow to show respet.
GEN 43:29 Wen Josef look up kon si en broda Benjamin, en mama pikin, e kon sey, “Na dis boy bi una yonga broda wey una tell mi about?” Den e sey, “My son, make God always dey good to yu.”
GEN 43:30 Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der.
GEN 43:31 Den e wosh en face kon kom out. With strong mind, e kon sey, “Make una arrange di food.”
GEN 43:32 Dem arrange one place for am, anoda place for en brodas and anoda place for di Egypt pipol wey won chop with am. (Dis na bikos, Egypt pipol nor dey chop with Hibru pipol, bikos Egypt pipol bilive sey e nor good to chop with Hibru pipol.)
GEN 43:33 Dem sidan for en front as dem take born dem; from di first-born go rish di last born. Di men kon dey sopraiz dey look demsef.
GEN 43:34 E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.
GEN 44:1 Josef kon tell di savant wey dey kare for en house sey, “Make yu pak food full dia sak kon give evribody dia money back.
GEN 44:2 Den make yu put my silva cup for di yonga one sak, plus en money.” So di man do as Josef tell am.
GEN 44:3 Wen morning rish, di men and dia donkey kon go.
GEN 44:4 Dem neva go far from di town wen Josef tell di savant wey dey kare for en house, “Make yu porshu dem at wons! Wen yu katch dem, tell dem sey, ‘Wetin make una repay bad for good?
GEN 44:5 Wetin make una tif my oga silva cup wey e dey use drink and shek di future? Una don do bad!’ ”
GEN 44:6 Wen di savant katch dem, e kon tell dem di word.
GEN 44:7 Dem ansa di savant, “Wetin make awa oga tok like dis? E nor dey possibol for yor savant to do dat kind tin!
GEN 44:8 Si! Di money wey wi si for awa sak before, wi bring am kom back. So wetin go make us tif silva or gold from yor oga house?
GEN 44:9 If any of us tif am, e go die and di remainin of us go bi awa oga savant!”
GEN 44:10 Di savant ansa, “Una don choose una own ponishment! Di pesin wey tif am go bi my savant, but di rest of una go-go free.”
GEN 44:11 So dem put dia sak for groun kon open am.
GEN 44:12 Den di man bigin shek. E start with di old one first till e rish di last one. Dem kon si di cup for Benjamin sak!
GEN 44:13 Den all of dem kon tear dia klot! Den dem arrange dia donkey kon go back to di town.
GEN 44:14 So Judah and en brodas kon go back to Josef house. Josef still dey house, so dem kon fall dey beg am.
GEN 44:15 Josef tell dem, “Wetin una tink sey una do so? So una nor know sey pesin like mi dey know tins before e happen?”
GEN 44:16 Judah ansa, “My oga, wetin wi go fit tell yu? Wetin wi go fit tok? How wi go fit take free awasef? God don espose awa sin! My oga, wi don bi yor savant, wi and di pesin wey dem si di cup for en sak.”
GEN 44:17 But Josef tell dem, “I nor go fit do dat tin! Di man wey dem for si di cup for en hand go bi my savant and di rest of una fit go meet una papa with peace.”
GEN 44:18 Den Judah ansa Josef, “My oga, abeg make yu let yor savant tok to yu. Abeg make yu nor vex with yor savant, bikos yu just bi like Fero.
GEN 44:19 My oga ask en savants sey, ‘Una still get papa or broda?’
GEN 44:20 Wi ansa sey, ‘Awa papa don old and wi get one small broda wey dem born for awa papa wen e don old. Di boy broda don die. Na only en bi en mama pikin wey remain and en papa love am well-well.’
GEN 44:21 Den yu tell us yor savants sey, ‘Make una go bring am kom make I si am.’
GEN 44:22 Wi tell awa oga sey, ‘Di boy nor go fit leave en papa. If e leave en papa, di papa go die.’
GEN 44:23 But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
GEN 44:24 Wen wi go meet awa papa, wi tell am evritin wey awa oga tok.
GEN 44:25 Den awa papa sey, ‘Make una go buy some food kom.’
GEN 44:26 But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’
GEN 44:27 Den yor savant, awa papa kon sey, ‘Una know sey my wife born two boys for mi.
GEN 44:28 Di first boy disappear and I kon sey, “Wiked animal go don chop am to pieces.” I neva si am since den.
GEN 44:29 If una take dis one from mi too and sometin happen to am, den una go make mi die for pain and shame.’
GEN 44:30 “So naw, how wi won take go back to yor savant, awa papa and di boy nor dey with us; bikos en life dey inside dis en pikin life.
GEN 44:31 Wen e si sey di boy nor dey with us, e go die and yor savant go let awa papa yor savant die inside pain and shame.
GEN 44:32 True-true, yor savant kon tell en papa sey, ‘If I nor bring di boy kom back, den for di rest of my life, I go dey bear di blame.’
GEN 44:33 So naw, make yu allow mi bi yor slave instead of dis boy. But for di boy, make e follow my brodas go back.
GEN 44:34 How I won take go back go tell my papa, if di boy nor dey with mi? I nor go fit bear to si my papa sofa for pain.”
GEN 45:1 Josef nor fit kontrol ensef again so e kon sey, “Make evribody komot for my front naw!” Nobody dey der with Josef wen e tell en brodas who e bi.
GEN 45:2 E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.
GEN 45:3 Josef kon tell en brodas, “I bi Josef! My papa still dey alive?” En brodas nor fit ansa am, bikos dem sopraiz well-well with fear as dem stand for en front.
GEN 45:4 Josef kon tell dem, “Make una waka near mi,” so dem waka near am. Den e sey, “I bi Josef una broda wey una sell give pipol wey dey kom Egypt.
GEN 45:5 Naw, make una nor fear or dey vex with unasef, bikos even doh una sell mi kom here, na God send mi go for una front, so dat pipol life go dey save!
GEN 45:6 Bikos for dis two years wey honga dey so, na so honga go still dey for di next five years.
GEN 45:7 So God send mi kom for una front, so dat una go dey di eart and una nor go die.
GEN 45:8 So naw, nor bi una send mi kom here, but na God. E don turn mi to Fero adviser, di oga ova all en propaty and di ruler for Egypt land.
GEN 45:9 “Naw, make una kwik-kwik go tell my papa sey, ‘Dis na wetin Josef yor pikin tok: “God don make mi oga ova all di land for Egypt. So make yu kwik-kwik kom meet mi!
GEN 45:10 Una go dey for Goshen land and una go dey near mi; both una, una shidren, una grand-shidren, una animals and plants and evritin wey una get.
GEN 45:11 I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’
GEN 45:12 “Una with my broda Benjamin don si sey na mi, Josef, dey follow una dey tok.
GEN 45:13 So make una tell my papa about all my honor for Egypt and about evritin wey una dey si so. But make una kwik bring my papa kom meet mi for here!”
GEN 45:14 Den Josef hold en broda Benjamin near body kon kry well-well and Benjamin kon dey kry too.
GEN 45:15 Josef kiss all en brodas as e dey kry. Afta, en brodas kon follow am tok.
GEN 45:16 Naw dem kon go tell Fero for en house sey, “Josef brodas don kom.” Di news sweet Fero and en savants.
GEN 45:17 Fero kon tell Josef, “Make yu go tell yor brodas sey, ‘Make una do like dis: Make una load una animal kon go Kanaan land!
GEN 45:18 Den make una karry una papa and family kom stay here! Den I go give una di best land for Egypt and una go dey chop di best food for dis land.’
GEN 45:19 Make yu still tell dem sey, ‘Make una do like dis: Una go karry horse wey dey karry load from dis land kon go karry una family kom from Kanaan; both una wifes and shidren. Make una bring una papa kom too.
GEN 45:20 Make una nor worry about una propaty, bikos di best tins wey dey Egypt go bi una own.’ ”
GEN 45:21 So Israel sons kon do as Josef tell dem. Josef give dem horse wey dey karry load, just as Fero tok kon give dem tins wey dem go nid for dia journey.
GEN 45:22 E still give all of dem many klot, but e give Benjamin three hundred silva and five klot.
GEN 45:23 E send dis tins go meet en papa: ten donkey wey karry di best goods for Egypt and ten woman donkey wey karry korn, food and di tins wey en papa go nid for en journey.
GEN 45:24 Den e send en brodas go and dem kon komot from en present. E tell dem, “As una dey travel, make una nor let fear worry una.”
GEN 45:25 So dem komot from Egypt go meet dia papa, Jakob for Kanaan.
GEN 45:26 Dem tell dia papa, “Josef neva die and na en dey rule Egypt!” Jakob kon sopraiz, bikos e nor bilive dem.
GEN 45:27 But wen dem tell Jakob evritin wey Josef tell dem and wen e si di horse wey Josef send kom karry am, e kon bilive sey na trut.
GEN 45:28 Den Israel sey, “E don do! My pikin Josef still dey alive! I go-go si am before I die.”
GEN 46:1 So Israel kon start en journey and e karry evritin wey e get follow body. Wen e rish Beersheba, e offa sakrifice give en papa Isaak, God.
GEN 46:2 Wen Israel dey sleep for nite, God kon tok to am for vishon sey, “Jakob, Jakob!” E ansa, “Na mi bi dis!”
GEN 46:3 God sey, “Na mi bi God, di God wey yor papa serve. Make yu nor fear to go Egypt, bikos na der I go for make yu bi one strong nashon.
GEN 46:4 I go follow yu go Egypt and na mi go take my hand bring yu kom back to dis land. Josef go kare for yu till yu die for Egypt.”
GEN 46:5 Den Jakob komot from Beersheba and Israel sons put dia papa, dia shidren and dia wifes for di horse wey Fero send kom kon karry dem go Egypt.
GEN 46:6 Jakob and all en shidren karry dia animals and propaty wey dem get for Kanaan kon go Egypt.
GEN 46:7 Jakob karry en sons and grand sons, en dota and grand dotas and evritin wey e get, enter Egypt.
GEN 46:8 Dis na di name of Israel shidren wey follow am go Egypt, dat is Jakob and en sons: Reuben, Jakob first-born
GEN 46:9 Reuben sons na: Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
GEN 46:10 Simeon sons na: Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul (di pikin wey one Kanaan woman born for am).
GEN 46:11 Levi sons na: Gershon, Kohat and Merari.
GEN 46:12 Judah sons na: Er, Onan, Shelah, Perez and Zera (But Er and Onan die for Kanaan land). Perez sons na Hezron and Hamul.
GEN 46:13 Issakar sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.
GEN 46:14 Zebulun sons na: Sered, Elon and Jahleel.
GEN 46:15 All dis na di shidren wey Leah born for Jakob for Paddan Aram, with Dinah en dota. All en sons and dotas na thirty-three.
GEN 46:16 Gad sons na: Zifion, Haggi, Shuni, Ezbon, Eri, Arodi and Areli.
GEN 46:17 Asher sons na: Imnah, Ishvah, Ishvi, Beraya and Serah wey bi dia sista. Beraya sons na Heba and Malkiel.
GEN 46:18 All dis na di shidren wey Leah savant, Zilpah born. E born dem for Jakob and all of dem na sixteen.
GEN 46:19 Jakob wife Rashel born only: Josef and Benjamin.
GEN 46:20 Dem born Manasseh and Efraim give Josef for Egypt. Potifara wey bi priest for On, na en dota Asenat born dem for Josef.
GEN 46:21 Benjamin sons na: Bela, Beka, Ashbel, Gera, Naaman, Ehi, Rosh, Muppim, Huppim and Ard.
GEN 46:22 All dis na Rashel sons wey dem born give Jakob and dem bi fourteen.
GEN 46:23 Dan son na: Hushim.
GEN 46:24 Naftali sons na: Jahziel, Guni. Jeza and Shillem.
GEN 46:25 Dis na di shidren wey Rashel savant, Bilhah born. E born all of dem for Jakob and dem bi seven.
GEN 46:26 All Jakob main shidren wey follow am go Egypt, na sixty-six dem bi. (Jakob shidren wife dem nor dey join dis nomba.)
GEN 46:27 If wi kount di two sons wey dem born give Josef for Egypt, all di pipol wey Josef get for Egypt kon bi seventy.
GEN 46:28 Jakob kon send Judah for front go tell Josef make e kon follow am go Goshen. So dem kon rish Goshen land.
GEN 46:29 Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry.
GEN 46:30 Israel kon tell Josef, “As long as I don si yor face kon know sey yu dey alive, I fit die naw.”
GEN 46:31 Den Josef tell en brodas and evribody wey dey en papa house sey, “I go-go tell Fero sey, ‘My brodas and my papa family wey bin dey for Kanaan, don kom follow mi stay.
GEN 46:32 Di men sabi guide animal; dem dey kare for animals well-well. Dem kom with dia animals, plants and evritin wey dem get.’
GEN 46:33 Wen Fero koll and ask una sey, ‘Na wetin una dey do?’
GEN 46:34 Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”
GEN 47:1 Josef kon go tell Fero sey, “My papa, my brodas, dia animals and evritin wey dem get don kom from Kanaan. Dem dey for Goshen.”
GEN 47:2 Josef take five among en brodas kon introduce dem to Fero.
GEN 47:3 Fero kon ask Josef brodas, “Na wetin una dey do.” Dem ansa, “Yor savants dey kare for animals, just as awa grand-grand papa dem do.”
GEN 47:4 Den dem tell Fero, “Wi just won stay for dis land for sometaim. Wi nor get food for awa animals, bikos of di honga for di whole Kanaan. So wi beg, make yu let wi yor savant stay for Goshen.”
GEN 47:5 So Fero tell Josef, “Na yu yor papa and brodas kom meet.
GEN 47:6 Egypt dey yor hand, so make yu do as yu like to yor papa and brodas. Dem fit stay for Goshen and if yu know any strong one among dem, yu fit gi-am my animals make e guide dem.”
GEN 47:7 Den Josef take en papa Jakob go meet Fero. Jakob kon bless Fero.
GEN 47:8 Fero ask Jakob, “How many years yu don spend for dis life?”
GEN 47:9 Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”
GEN 47:10 Den Jakob bless Fero kon komot from der.
GEN 47:11 So Josef make en papa and brodas setol down. E give dem one aria for Egypt, di best aria for di land; wey bi Rameses land, just as Fero tok.
GEN 47:12 Josef still provide food for en papa, en brodas, all en papa pipol, akordin to di shidren wey dem get.
GEN 47:13 But food nor dey di land again, bikos di honga for evriwhere, strong well-well. So pipol kon die anyhow for Egypt and Kanaan land, bikos food nor dey.
GEN 47:14 Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, so Josef kollect and karry all di money go give Fero for en palis.
GEN 47:15 So wen Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, all di pipol for Egypt kon go meet Josef dey sey, “Make yu give us food! Abi yu wont make wi die for yor front, bikos awa money don finish?”
GEN 47:16 Den Josef sey, “If una money don finish, make una bring una animals kon give mi and I go give una food.”
GEN 47:17 So dem bring all dia animals kon give Josef and Josef give dem food afta dem don drop dia horse, sheep and kattle. E save dem dat year, bikos e still dey give dem food chop wen dem bring dia animals.
GEN 47:18 Wen dat year don finish, dem kon meet am di next year dey sey, “Wi nor fit hide am from awa oga sey di money and all awa animals don finish.
GEN 47:19 Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”
GEN 47:20 So Josef buy all di land for Egypt kon gi-am to Fero. Evribody for Egypt sell dia field, bikos di honga dey strong evriday. So all di land for Egypt kon bi Fero own.
GEN 47:21 So Josef kon make evribody for Egypt turn slave.
GEN 47:22 But e nor buy di priests land, bikos di priests get favor from Fero eye, so dem dey chop from di share wey Fero give dem. Dat na why dem nor sell dia land.
GEN 47:23 Josef kon tell di pipol, “Since I don buy una and una land for Fero, make una take seed kon go plant for di land.
GEN 47:24 Wen una don harvest wetin una plant, make una divide am into ten kon give five part to Fero and una with una family fit chop di rest.”
GEN 47:25 Dem ansa, “Yu don save awa life! Yu don show us favor and wi go bi Fero savants.”
GEN 47:26 So wetin Josef tok kon bi law for Egypt and dem dey obey am kon rish today: wen dem divide evritin, five part na Fero own. Na only di priests land nor bi Fero own.
GEN 47:27 Israel stay for Egypt, for Goshen and dem kon get land for der.
GEN 47:28 Jakob stay seventeen years for Egypt; so all di years wey Jakob stay, na one hundred and forty-seven years.
GEN 47:29 Di time wey Israel won die kon rish, so e koll en pikin Josef kon tell am, “If really sey yu love mi, make yu put yor hand under my lap kon show mi kindness and faithfulnes. Make yu nor beri mi for Egypt,
GEN 47:30 but wen I die, karry mi komot from Egypt go beri for my papa burial groun.” So Josef sey, “Papa! I go do as yu tok.”
GEN 47:31 Israel sey, “Make yu promise mi sey yu go do as I tok.” So Josef promise. Den Israel bow face groun for en bed korna.
GEN 48:1 Afta dis, dem kon tell Josef, “Yor papa nor dey strong again.” So e take en two sons, Manasseh and Efraim go meet am.
GEN 48:2 Wen dem tell Jakob sey, “Yor pikin Josef don kom meet yu,” e kon get up sidan for en bed.
GEN 48:3 Jakob tell Josef, “Di God wey get pawa appear to mi for Luz wey dey Kanaan land kon bless mi.
GEN 48:4 E tell mi sey, ‘I go make yu get shidren and propaty and dem go many well-well. I go make many nashons kom from yu and I go give dis land to yor shidren-shidren as dia own forever.’
GEN 48:5 Naw, koncerning yor two pikin wey yu born for Egypt before I kom here, dem go mi my own. Just as Efraim and Manasseh bi my own, na so Reuben and Simeon go bi my own too.
GEN 48:6 But any pikin wey yu go born afta dem, go bi yor own; wen dem won share di propaty for di promise land, dia name go dey under Manasseh and Efraim name.
GEN 48:7 But for mi, wen I dey kom back from Paddan, Rashel die kon make mi kry for Kanaan. E die for road, wen wi still dey far from Efratah. So I beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).”
GEN 48:8 Wen Jakob si Josef sons, e kon ask, “Na who bi dis?”
GEN 48:9 Josef tell en papa, “Dem bi di pikin wey God don give mi for dis place.” En papa kon sey, “Bring dem kom meet mi, so dat I go bless dem.”
GEN 48:10 For dis time, Jakob nor dey si well again, bikos e don old well-well. So Josef take en sons near am well-well and en papa hold dem near en body kon kiss dem.
GEN 48:11 Israel tell Josef, “I nor bilive sey I go si yu again, but naw, God don let mi even si yor shidren too.”
GEN 48:12 So Josef take dem komot from Israel leg kon bow face groun.
GEN 48:13 Josef arrange dem; e use en rite hand take direct Efraim go Jakob left hand kon use en left hand direct Manasseh go Jakob rite hand. Den Josef take dem go meet en papa.
GEN 48:14 Israel take en rite hand put am on-top Efraim head, even doh na en bi di yonga one. As e cross en hand, e kon put di left hand on-top Manasseh head, but na Manasseh bi first-born.
GEN 48:15 Den Israel bless Josef kon sey, “Make di God wey yor grand-papa Abraham and Isaak serve; di God wey dey guide mi since thru-out my life kon rish today;
GEN 48:16 di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
GEN 48:17 Wen Josef si sey en papa put en rite hand for Efraim head, e nor happy. So e try remove en papa rite hand from Efraim head go Manasseh head.
GEN 48:18 Josef tell en papa, “My papa, nor bi so, na Manasseh bi first-born, so make yu put yor rite hand for en head.”
GEN 48:19 But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.”
GEN 48:20 So Israel bless dem dat day kon sey, “Na thru una Israel pipol go dey bless wen dem sey, ‘Make God bless us like Efraim and Manasseh.’ ”
GEN 48:21 Den Israel tell Josef, “Na die I dey so, but God go dey with yu and e go take yu go back to yor papa land.
GEN 48:22 Bikos yu dey higher dan yor brodas, I go give yu di low side for di mountin wey I take from Amor pipol with my swod and bow.”
GEN 49:1 Den Jakob koll all en sons kon sey, “Make all of una kom, so dat I go tell una wetin go happen for future.
GEN 49:2 “Make una listin to mi, una wey bi Jakob shidren; make una listin to Israel wey bi una papa.
GEN 49:3 Reuben, na yu I first-born, my strent and di first fruit wey I plok. Na yu bi di nomba one, both for rank and pawa.
GEN 49:4 But yu dey skata tins like wota, so yu nor go prosper, bikos yu sleep with yor papa wife for my bed!
GEN 49:5 Simeon and Levi na brodas, dem like war and trobol well-well!
GEN 49:6 Make I neva ever join dia meetin or go where dem for gada dey make plan. Bikos as dem dey vex, dem kill many pipol kon break animals leg just as dem like.
GEN 49:7 I curse dia wiked mind, bikos e too strong and dia annoyance, bikos e dey bad well-well. I go divide dem inside Jakob family kon skata dem among Israel pipol!
GEN 49:8 Yu Judah, yor brodas go praiz yu. Yor hand go strong pass yor enemy own. Yor papa sons go bow down for yu.
GEN 49:9 Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?
GEN 49:10 Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
GEN 49:11 E tie en donkey put for di vine, di vine wey e choose. Na wine e take dey wosh en klot and na grape e take dey wosh en garment.
GEN 49:12 En eyes dark pass wine and en tit white pass milk.
GEN 49:13 Zebulun go dey stay near di sea and e go dey kontrol many sheep for di sea, en land go long go rish Sidon.
GEN 49:14 Issakar na very strong donkey wey dey rest on-top two strong bags.
GEN 49:15 Wen e si how di kountry side bi and how di land good, e go fit bear di load wey e karry kon bi savant to odas.
GEN 49:16 Dan go rule pipol like any oda tribe for Israel.
GEN 49:17 Dan go bi like snake wey dey di road korna; like betta wiked snake wey dey bite horse leg, so dat who dey ride am go fall.
GEN 49:18 My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!
GEN 49:19 Pipol wey dey tif, go attack Gad, but e go attack dem wen dem don go back.
GEN 49:20 Na rish-rish food Asher go dey chop and e go dey provide betta food for kings.
GEN 49:21 Naftali go bi like animal wey dey free; di words wey e go tok, go dey good well-well.
GEN 49:22 Josef na betta vine wey dey produce good food; betta vine wey dem plant near wota and en branches dem dey klimb di wall.
GEN 49:23 Hunta go attack am, dem go shot and oppoz am.
GEN 49:24 But en bow go dey strong and e nor go move and e hand go sabi work bikos of Jakob God, di Shepad, wey bi di Rock for Israel,
GEN 49:25 una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.
GEN 49:26 Una papa blessing dey great pass all di blessings wey dey from di mountins go rish di hills. Dis blessings go rest for Josef head, bikos e bi prince among en brodas.
GEN 49:27 Benjamin go bi like wolf wey dey skata en enemy. For morning, e dey distroy wetin e katch and for evening, e dey divide wetin e katch.”
GEN 49:28 Dis na di twelf tribes for Israel. Dis na wetin dia papa tell dem wen e dey bless dem. E bless all of dem as e suppose bless dem.
GEN 49:29 Den Jakob kommand sey, “I go soon die. So, make una beri mi with my papa dem for di grave wey dey Efron field for Hit land.
GEN 49:30 Na di grave wey dey Makpelah field for Mamre land for Kanaan, wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.
GEN 49:31 Na der dem for beri Abraham and en wife Sarah; na der two dem for beri Isaak and en wife Rebekah and na der I for beri Leah.
GEN 49:32 Dem buy di field and di grave wey dey inside from Het shidren.”
GEN 49:33 Wen Jakob don kommand all en sons finish, e karry en leg well enter di bed, breath en last breath, den e kon die.
GEN 50:1 Den Josef kiss en papa for face kon kry well-well, bikos of am.
GEN 50:2 Josef kon tell di doctor sey make e dress di dead body, so di doctor kon dress Israel (wey bi Jakob).
GEN 50:3 E dress am well, so dat di body go fit dey der for forty day, bikos dat na di normal time wey di body suppose last. Egypt pipol use seventy days take mourn for am.
GEN 50:4 Wen dem don mourn finish, Josef kon tell Fero ofisas, “If really sey una like mi, make una tell Fero sey,
GEN 50:5 ‘My papa make mi swear wen e sey, “I go soon die. Make yu beri mi for di grave wey I dig for mysef for Kanaan.” Naw make I go beri my papa; den I go kom back.’ ”
GEN 50:6 So Fero sey, “Make yu go beri yor papa, just as e make yu swear sey yu go do.”
GEN 50:7 So Josef go beri en papa and all Fero ofisas follow am go; from di senior ofisas go rish di oda ones for di hold Egypt,
GEN 50:8 Josef family, en brodas and en papa family. But dem leave di small-small shidren and dia animal for Goshen.
GEN 50:9 War horse and di driver still follow am go, so pipol wey follow am many well-well.
GEN 50:10 Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa.
GEN 50:11 Wen Kanaan pipol wey dey stay di land si dem dey mourn for Atad, dem kon sey, “Wetin happen nor good at-all for Egypt pipol.” Dat na why dem dey koll di place Abel Mizraim and e dey afta Jordan River.
GEN 50:12 So Jakob shidren do for am, just as e kommand dem before.
GEN 50:13 En sons karry am go Kanaan kon beri am for di grave wey dey Makpelah field near Mamre. Dis na di field wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.
GEN 50:14 Afta Josef don beri en papa, e kon go back to Egypt with en brodas and evribody wey follow am.
GEN 50:15 Wen Josef brodas si sey dia papa don die, dem kon sey, “Wot of if Josef still dey vex and e kon sey e go ponish us for evritin wey wi do am?”
GEN 50:16 So dem kon go tell Josef sey, “Yor papa give dis kommand before e die sey:
GEN 50:17 ‘Make una tell Josef: “Make yu forgive yor brodas dia sins and di bad tins wey dem do yu.” ’ Naw make yu forgive di sins wey yor broda God savant, kommit.” Wen dem tell Josef di message, Josef kry well-well.
GEN 50:18 Den en brodas kom fall for en front dey sey, “Na wi bi dis and wi bi yor savants.”
GEN 50:19 But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do.
GEN 50:20 Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.
GEN 50:21 So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.
GEN 50:22 Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years.
GEN 50:23 Josef si Efraim shidren-shidren. E still si Manasseh pikin Makir and en shidren; Josef give dem betta land and propaty.
GEN 50:24 Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
GEN 50:25 Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.”
GEN 50:26 So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
EXO 1:1 Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body:
EXO 1:2 Reuben, Simeon, Levi, Judah,
EXO 1:3 Issakar, Zebulun, Benjamin,
EXO 1:4 Dan, Naftali Gad and Asher.
EXO 1:5 Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
EXO 1:6 Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die.
EXO 1:7 So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land.
EXO 1:8 Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt.
EXO 1:9 So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us!
EXO 1:10 Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
EXO 1:11 So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.
EXO 1:12 But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well,
EXO 1:13 so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow.
EXO 1:14 Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.
EXO 1:15 Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey;
EXO 1:16 “Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.”
EXO 1:17 But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
EXO 1:18 Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?”
EXO 1:19 Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!”
EXO 1:20 So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong.
EXO 1:21 Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
EXO 1:22 So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”
EXO 2:1 For dis time, one man from Levi tribe marry one woman wey kom from di same tribe.
EXO 2:2 Di woman get belle kon born boy. Wen e si sey di pikin fine well-well, e kon hide am for three mont,
EXO 2:3 but as e nor fit hide am again, e take basket wey dem make with soft wood kon wrap am, so dat wota nor go enter inside. E put di pikin inside kon put am near di grass dem wey dey River Nile korna.
EXO 2:4 Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.
EXO 2:5 Den Fero dota kom di river kon baf and as en savants dey waka for di river korna, at wons di king dota kon si di basket for where di grass dem dey. So e send one among en savants go bring am kom.
EXO 2:6 Wen e open di basket, e kon si di boy inside dey kry. Fero dota sorry for di pikin kon sey, “Dis go bi one Hibru woman pikin.”
EXO 2:7 Den di pikin sista kon ask Fero dota, “Yu wont make I go find one woman among di Hibru wimen wey go fit kare for dis pikin for yu?”
EXO 2:8 Fero dota ansa, “Make yu go.” So di yong girl kon go bring di pikin mama kom.
EXO 2:9 Fero dota tell di woman, “Go take kare of dis pikin for mi and I go pay yu for di work.” So di pikin mama karry am kon go kare for am.
EXO 2:10 Wen di pikin don big rish, di woman kon karry am go give di king dota as en pikin and e name am, “Moses” bikos e sey, “Na wota I for si am.”
EXO 2:11 Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.
EXO 2:12 As Moses si sey nobody dey look dem, e attack, kill and beri di Egypt man.
EXO 2:13 Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”
EXO 2:14 Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?” Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.”
EXO 2:15 Wen Fero hear about di matter, e kon dey fine Moses make e kill-am. So Moses run from Fero go Midian land kon go stay near one well.
EXO 2:16 Naw, Midian priest get seven girls wey dey kom draw wota from di well to take feed dia papa animals.
EXO 2:17 So some shepad kom drive di girls komot from di well, but Moses fight for dem kon give dia animals wota.
EXO 2:18 Wen di girls rish house, Jetro, dia papa kon ask, “Wetin make una kwik kom house today?”
EXO 2:19 Dem ansa, “Na one Egypt man save us from doz shepad, den e draw wota for us kon still give di animals drink.”
EXO 2:20 Di man ask en dotas, “Na where dis man dey and wetin make una leave am for der? Make una go koll am kom, so dat e go follow us chop today.”
EXO 2:21 Moses agri to stay with dem and di man kon give en dota, Zipporah to Moses as en wife.
EXO 2:22 Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”
EXO 2:23 Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven.
EXO 2:24 God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob.
EXO 2:25 God si as dem dey sofa, so E kon dey sorry for dem.
EXO 3:1 One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb.
EXO 3:2 Den God angel appear to am like fire for inside di bush. Wen Moses look, e si sey di fire dey katch, but di bush nor dey burn!
EXO 3:3 So Moses tok for en mind sey, “I neva si dis kind tin before. I go waka near kon si why di bush nor dey burn?”
EXO 3:4 Wen God si sey Moses don near di bush, E kon koll am, “Moses, Moses!” Den Moses ansa, “I dey here.”
EXO 3:5 God tell am, “Make yu nor waka near dis place. Remove di shoe wey dey yor leg, bikos di groun wey yu stand put so, dey holy.”
EXO 3:6 E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.
EXO 3:7 God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.
EXO 3:8 I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
EXO 3:9 True-true, Israel pipol kry don rish my ear and I don si how Egypt pipol dey sofa and opress dem.
EXO 3:10 So naw, make yu go, bikos na mi dey send yu go meet Fero and make yu take my pipol Israel, komot from Egypt.”
EXO 3:11 But Moses tell God, “Na who I bi to go meet Fero or to karry Israel pipol komot from Egypt?”
EXO 3:12 God ansa am, “True-true, I go dey with yu and dis go bi di sign to show sey na mi send yu: wen yu take di pipol komot from Egypt, yu and dem go kom serve mi for dis mountin.”
EXO 3:13 But Moses ansa God, “If I go meet Israel pipol kon tell dem, ‘Na una grand-grand papa God send mi kom meet una.’ Den dem ask mi, ‘Wetin bi en name?’ Na wetin I go ansa dem?”
EXO 3:14 God ansa, “I bi Who I bi. Dis na wetin yu go tell dem, ‘Na di God wey bi who E bi send mi kom meet una.’ ”
EXO 3:15 God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
EXO 3:16 “So make yu go gada di eldas for Israel kon tell dem sey, ‘God wey bi una grand-grand papa dem, Abraham, Isaak and Jakob God appear to mi kon sey, “I don kom meet una and I si as una dey sofa.
EXO 3:17 I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’
EXO 3:18 “Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’
EXO 3:19 “But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am.
EXO 3:20 So I go use my hand skata Egypt with all di wonders wey I go do among dem and afta all doz tins, e go let una go.
EXO 3:21 I go make Egypt pipol favor una, so dat una go karry tins follow body wen una dey komot from di land.
EXO 3:22 All di wimen for Israel go ask dia neighbour and Egypt neighbour for gold, silva and fine-fine klot. Una and una shidren go wear dem and like dis, una go finish all di tins wey Egypt pipol get!”
EXO 4:1 Moses ansa again, “Na wetin I go do if dem nor bilive or listin to mi, but kon dey sey, ‘God nor appear to yu’?”
EXO 4:2 So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?” E ansa, “Na stik.”
EXO 4:3 God tell am, “Make yu trow am for groun.” So Moses trow di stik for groun and e turn to snake, den Moses run komot der.
EXO 4:4 But God tell am, “Make yu hold am for en tail.” So e hold am for en tail and di snake kon turn stik for en hand.
EXO 4:5 God sey, “Dis na wetin yu go do, so dat Israel pipol go bilive sey na di Oga God wey bi dia grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob God, appear to yu.”
EXO 4:6 God still tell am, “Make yu put yor hand inside yor dress.” So e put en hand inside en dress and wen e bring am kom out, e kon get diziz and di hand dey white like snow!
EXO 4:7 God tell am, “Put yor hand back inside yor dress.” So e put am back, den e bring am kom out and di hand kon dey okay again.
EXO 4:8 So God sey, “If dem nor bilive yu or bilive di first sign, dem go bilive dis sekond one.
EXO 4:9 And if dem nor bilive dis two signs or listin to yu, make yu take small wota from River Nile kon pour am for dry groun. Den di wota wey yu fetch from di river go turn to blood as yu dey pour am.”
EXO 4:10 Den Moses tell God, “My Oga God, Yu know sey I nor sabi tok well since dem born mi kon rish naw wey Yu dey tok to mi, yor savant.”
EXO 4:11 God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
EXO 4:12 Naw, make yu go and I go help yu tok kon tell yu wetin yu go tok.”
EXO 4:13 But Moses sey, “My Oga God, abeg make Yu send anoda pesin wey Yu go like to send.”
EXO 4:14 Den Oga God kon dey vex with Moses, so E ask am, “Wot about yor broda Aaron wey kom from Levi tribe? I know sey e sabi tok well-well. E dey kom meet yu and wen e si yu, e go happy well-well.
EXO 4:15 Den yu go tell am wetin e go tok. As for mi, I go tok thru una and I go tish two of una wetin to do.
EXO 4:16 E go help yu tok to di pipol and e go bi like sey naim bi yor mout and yu go bi like God to am.
EXO 4:17 Yu go still karry di stik follow body, bikos naim yu go take do many signs and wonders.”
EXO 4:18 Den Moses go back go meet en wife papa, Jetro kon tell am, “Make yu allow mi go back to my family for Egypt kon shek if dem still dey alive.” Jetro ansa Moses, “Make peace follow yu go.”
EXO 4:19 God tell Moses for Midian, “Make yu go Egypt back, bikos all di pipol wey get mind to kill yu, don die.”
EXO 4:20 Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.
EXO 4:21 God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.
EXO 4:22 Yu must tell Fero, ‘God sey, Israel na my first pikin
EXO 4:23 and I tell yu sey, “Make yu allow my pikin dem go, so dat dem go-go serve mi, but since yu nor gri make dem go, I go kill yor own son!” ’ ”
EXO 4:24 Naw, nite meet dem for road, so dem stop for one house kon sleep der. For nite wen dem dey sleep, God won kon kill Moses for di place.
EXO 4:25 But en wife Zipporah kut en son skin with knife kon take am tosh Moses leg, den e sey, “True-true, I don take yu from deat hand and yu bi my husband wey I marry with blood.”
EXO 4:26 So God leave Moses. (From dat time, en wife kon dey koll am, “Blood husband” and e take am mean sekonsishon.)
EXO 4:27 God tell Aaron, “Make yu go di wildaness go meet Moses.” So Aaron go der go meet am for God mountin kon kiss am.
EXO 4:28 Moses tell Aaron evritin wey God tell am and all di mirakle and sign wey God kommand am sey make e do.
EXO 4:29 Den Moses and Aaron kon go gada all di eldas for Israel togeda.
EXO 4:30 Aaron tell dem wetin God tell Moses and Moses do di mirakles and signs for di pipol front,
EXO 4:31 so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.
EXO 5:1 Den Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “Israel God sey, ‘Make yu allow my pipol travel go di wildaness go woship and honor mi.’ ”
EXO 5:2 But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”
EXO 5:3 Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”
EXO 5:4 Den di king tell dem, “Moses and Aaron, na una dey make di pipol nor gri do dia work, abi? Make una go back go kontinue una work.
EXO 5:5 Una pipol don too many for dis land pass Egypt pipol. And naw, una wont stop work.”
EXO 5:6 For dat di same day, Fero kon kommand di slave oga dem sey,
EXO 5:7 “Make una stop to give di pipol wetin dem take dey make block. But make only dem go find kon make block.
EXO 5:8 And una go force dem make plenty block, just as dem dey do before. Na bikos dem nor get enough work naim make dem dey kom ask mi sey, ‘Make yu let us go sakrifice give awa God.’
EXO 5:9 Make una give dem strong work, so dat dem nor go get shance to listin to lie-lie word!”
EXO 5:10 So all di slave oga kon go tell Israel pipol, “Fero sey: ‘I nor go give una wetin dem take dey make block again.
EXO 5:11 But na only una go-go find dem and di block wey una go make must bi di same as before.’ ”
EXO 5:12 So di pipol kon bigin waka for inside Egypt dey find wetin dem take dey make block.
EXO 5:13 Di slave oga still dey force and tell dem, “Una must finish evriday work, just as e bi wen wi dey give una dry stik take work!”
EXO 5:14 Fero pipol kon bigin beat Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol, den dem ask dem, “Why una nor komplete una work yestiday and today, just as una dey do before?”
EXO 5:15 Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol kry go meet Fero kon sey, “Why yu dey sofa yor savants like dis?
EXO 5:16 Dem nor gri give us, yor savants dry stik, instead dem dey beat and tell us sey make wi make plenty block, even doh na dem dey wrong.”
EXO 5:17 Den Fero ansa, “Una lazy and nor won work, if not una nor go sey, ‘Make yu allow us go sakrifice give awa God.’
EXO 5:18 So make una go back go work. Dem nor go give una dry stik again and una must still make di block rish as una dey do am before!”
EXO 5:19 Israel pipol wey dem take make oga ova dia own pipol kon know sey dem don enter trobol as di king sey, “Una must make di block rish as una bin dey do am.”
EXO 5:20 Afta dem leave Fero, dem kon go meet Moses and Aaron wey bin dey wait for dem kon
EXO 5:21 sey, “Make God judge una, bikos una don make di king and en workers hate us and una don give dem shance to kill us!”
EXO 5:22 Moses go back go meet God kon sey, “God! Why Yu kon kause trobol for dis pipol? Wetin make Yu send mi kom?
EXO 5:23 Since I go tok to Fero with yor name, di kind sofa wey e dey sofa yor pipol kon worse pass as e bi before and Yu neva still kom save dem!”
EXO 6:1 Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.”
EXO 6:2 So God tell Moses, “Na mi bi Oga God.
EXO 6:3 ‘Na mi appear to Abraham, Isaak and Jakob as di Almighty God, but di pipol nor know sey my name na Oga God,’ too.
EXO 6:4 I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’
EXO 6:5 Naw, I don hear Israel pipol kry, bikos of how Egypt pipol dey sofa dem and I don remember my kovenant.
EXO 6:6 “So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.
EXO 6:7 I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.
EXO 6:8 I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ”
EXO 6:9 Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa.
EXO 6:10 Den God tell Moses,
EXO 6:11 “Make yu go tell Fero wey bi Egypt king sey e must free Israel pipol from en land.”
EXO 6:12 But Moses ansa, “If Israel pipol nor gri listin to mi, den how Fero go kon take listin to mi, since I nor dey fit tok well?”
EXO 6:13 God kon kommand Moses and Aaron about Israel pipol and E sey make dem tell Fero wey bi king for Egypt sey make e free Israel pipol from en land.
EXO 6:14 Dis na di head for di difren family for Israel: Reuben wey bi Israel first pikin, born Hanok, Pallu, Hezron and Karmi. Na dis pipol bi Reuben family.
EXO 6:15 Simeon shidren na Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul wey en mama kom from Kanaan. Na dis pipol bi Simeon family.
EXO 6:16 Levi shidren akordin to dia rekord na Gershon, Kohat and Merari. (Levi stay for one hundred and thirty-seven years.)
EXO 6:17 Gershon shidren akordin to dia family, na Libni and Shimei.
EXO 6:18 Kohat shidren na Amram, Izhar, Hebron and Uzziel. (Kohat stay for one hundred and thirty-three years.)
EXO 6:19 Merari shidren na Mahli and Mushi. Na dis pipol kon bi Levi family akordin to dia rekord.
EXO 6:20 Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die).
EXO 6:21 Di shidren wey Izhar born na Korah, Nefeg and Zikri.
EXO 6:22 Uzziel shidren na Mishael, Elzafan and Sitri.
EXO 6:23 Aaron marry Elisheba wey bi Amminadab dota and Nahshon sista. Di woman born Nadab, Abihu, Eleazar and Itama for Aaron.
EXO 6:24 Korah pikin na Assir, Elkanah and Abiasaf. Na dis pipol bi Korah family.
EXO 6:25 Naw, Eleazar wey bi Aaron pikin marry one among Putiel dota and e born Finehas for Eleazar. Na all dis pipol kon bi Levi tribe.
EXO 6:26 Na dis Aaron and Moses, God still tell sey, “Make una take Israel pipol komot from Egypt.”
EXO 6:27 Na dem bi di men wey tok to Fero, so dat dem go fit take Israel pipol komot from Egypt.
EXO 6:28 Wen God tok to Moses for Egypt,
EXO 6:29 E tell am, “Na mi bi di Oga, yor God. All di tins wey I dey tell yu since, make yu go tell Fero wey dey rule Egypt.”
EXO 6:30 But Moses ansa, “Since I nor fit tok well, how Fero go take listin to mi?”
EXO 7:1 So God tell Moses, “Si, I don turn yu to god for Fero front and yor broda, Aaron go bi yor profet.
EXO 7:2 Yu go tell am all di tins wey I tell yu and yor broda Aaron go tell Fero sey e must free Israel pipol.
EXO 7:3 But I go make Fero heart strong, even with all di signs and wonders wey I go do take warn am.
EXO 7:4 Fero nor go gri listin to una. So I go ponish Egypt pipol. I go use force take karry my pipol Israel komot from Egypt land, den judge Egypt pipol well-well.
EXO 7:5 Den wen I show Egypt pipol as I strong rish kon take Israel pipol komot from der, di pipol go know sey na mi bi Oga God.”
EXO 7:6 So Moses and Aaron do as God kommand dem.
EXO 7:7 Naw, Moses na eighty years while Aaron na eighty-three years wen dem go tok to Fero.
EXO 7:8 God tell Moses and Aaron,
EXO 7:9 “Wen Fero sey, ‘Make una do sometin to make mi bilive!’ Den yu go tell Aaron, Trow di stik for groun for Fero front and e go shange to snake.”
EXO 7:10 Wen Moses and Aaron go meet Fero, dem do as God kommand dem. Aaron trow di stik for groun for where Fero and en savants dey and e shange to snake.
EXO 7:11 Fero sef tell en native doctors and juju-men for Egypt sey make dem do di same tin.
EXO 7:12 All of dem trow dia stik for groun and dia stik turn to plenty snake. But Aaron stik swallow all di oda stiks.
EXO 7:13 With all dis ones, Fero heart still strong well-well and e nor gri listin to dem, just as God tok.
EXO 7:14 God tell Moses, “Fero heart dey strong and sturbon and e nor go gri allow di pipol go.
EXO 7:15 So make yu prepare yorsef go meet am for morning wen e dey go River Nile korna and make yu hold di stik wey shange to snake for yor hand.
EXO 7:16 Den yu go tell am, ‘Na Oga God, wey bi Hibru pipol God send mi kom tell yu sey, “Make yu let my pipol go serve mi for di wildaness! But yu nor won gri.” ’
EXO 7:17 God sey, ‘Naw, wetin I go do, go make yu know sey na mi bi Oga God.’ Si, I go nak di wota for River Nile with di stik wey dey my hand and e go shange to blood.
EXO 7:18 Di fish dem for inside di river go die; di river go dey smell and di pipol wey dey Egypt nor go fit drink from di wota again.”
EXO 7:19 Den God tell Moses, “Tell Aaron sey, ‘Make yu stresh yor stik wey dey yor hand on-top di river, creek and pond dem for Egypt and dem go turn to blood; even di wota wey dey inside wood and stone kontaina.’ ”
EXO 7:20 Moses and Aaron do as Oga God kommand dem. Aaron use di rod wey dey en hand take nak River Nile for where Fero and en savants dey and di river turn to blood.
EXO 7:21 Wen all di fish dem inside di river don die, di river kon dey smell and Egypt pipol nor fit drink from di wota again.
EXO 7:22 But di juju-men for Egypt still do di same tin with dia juju pawa and dis tin kon make Fero heart strong more-more and e nor gri listin to Moses and Aaron, just as Oga God tell dem.
EXO 7:23 So Fero go inside en house back. E nor even allow wetin happen worry en mind.
EXO 7:24 All Egypt pipol bigin dig groun near River Nile, so dat dem go si wota drink, bikos dem nor fit drink di wota wey dey di river.
EXO 7:25 Naw, seven days don pass wen God turn River Nile to blood.
EXO 8:1 Den God tell Moses, “Go tell Fero sey, ‘Dis na wetin God tok, “Make yu let my pipol go serve mi!
EXO 8:2 But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa.
EXO 8:3 Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota.
EXO 8:4 Di frog go trobol yu, yor pipol and all yor savants for dis land.” ’ ”
EXO 8:5 God tell Moses, “Go tell Aaron, ‘Take di stik wey dey yor hand take face di river, creek and di ponds and frog go full evriwhere for Egypt.’ ”
EXO 8:6 So as Aaron stresh di stik on-top di wota wey dey Egypt, frog kom full evriwhere for di land.
EXO 8:7 Di juju-men sef kon use dia juju pawa take bring frog join di ones wey dey di land.
EXO 8:8 Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
EXO 8:9 So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”
EXO 8:10 Fero ansa, “Na tumoro.” Den Moses sey, “E go bi as yu tok, so dat yu go know sey nobody bi like di Oga wey bi awa God.
EXO 8:11 Di frog go komot from yu, all yor savants and yor pipol house and na only di frog dem for inside River Nile, go remain.”
EXO 8:12 Moses and Aaron kon waka leave Fero. Den Moses pray to God make E remove di frog wey E send kon meet Fero.
EXO 8:13 God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die.
EXO 8:14 Egypt pipol gada di frog and dem nor fit kount am, den evriwhere kon dey smell for di land.
EXO 8:15 But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.
EXO 8:16 God kon tell Moses, “Make yu tell Aaron sey, ‘Nak di san with di stik wey dey yor hand and plenty san-san fly go kom out for evriwhere for Egypt.’ ”
EXO 8:17 So Aaron nak di san with en stik and san-san fly kon full evriwhere for Egypt.
EXO 8:18 Wen di juju-men try to bring out san-san fly with dia juju pawa, dem nor fit do am. So san-san fly kon dey gada both Egypt pipol and dia animals.
EXO 8:19 Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.
EXO 8:20 God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!
EXO 8:21 If yu nor gri let dem go, I go send plenty fly kom meet yu, yor savants, yor pipol and for inside una house. All Egypt pipol house and di groun go full with fly.
EXO 8:22 And for dat day, I nor go let di fly dem rish Goshen land where my pipol dey, so dat yu go know sey na mi, di Oga God dey do dis tins.
EXO 8:23 I go divide my pipol from yor pipol. Dis sign go happen tumoro.” ’ ”
EXO 8:24 God do as E tok and fly wey dem nor fit kount kon full Fero, en savants and Egypt pipol house and many tins spoil, bikos of di fly dem.
EXO 8:25 Den Fero koll Moses and Aaron kon sey, “Make una go sakrifice to una God inside di land.”
EXO 8:26 But Moses sey, “Dat nor bi wetin wi suppose do, di kind sakrifice wey wi won do for di Oga awa God na wetin Egypt pipol dey forbid. If wi make sakrifice wey Egypt pipol dey forbid for dia face, dem nor go stone us die?
EXO 8:27 So wi must travel for three days go inside di wildaness go sakrifice to di Oga awa God, just as E don dey tell us since.”
EXO 8:28 Fero kon sey, “I go let una go sakrifice give di Oga una God inside di wildaness, but una nor go-go too far. Make una pray for mi too.”
EXO 8:29 Moses ansa, “I go leave yu go pray to God and tumoro, all di fly go komot from Fero, en savants and en pipol, so-far yu nor go deceive us again or nor let us go sakrifice to awa God.”
EXO 8:30 So Moses komot from where Fero dey kon go pray
EXO 8:31 and Oga God do as Moses ask. E remove all di fly from Fero, en savants and en pipol.
EXO 8:32 But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.
EXO 9:1 Den Oga God tell Moses, “Go meet and tell Fero sey, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!
EXO 9:2 Bikos if yu nor gri let dem go and yu kontinue to hold dem,
EXO 9:3 I go use my pawa bring sickness kom meet una animals for fields, una horse, donkey, kamel, kattle, sheep and goat dem.
EXO 9:4 But I go separate Israel animals from Egypt pipol own. No Israel animal go die.” ’
EXO 9:5 “Mi wey bi Oga God don sey na tumoro I go do dis tin wey I tok.”
EXO 9:6 True-true God do dis tin for di next day. All di animals for Egypt pipol farm die, but no one for Israel pipol own, die.
EXO 9:7 Fero kon send pipol go find out and true-true, Israel pipol animal nor die. With all dis tins wey dey happen so, Fero heart still strong and e nor gri free di pipol.
EXO 9:8 Den Oga God tell Moses and Aaron sey, “Make una gada ashes from where dem for dey burn firewood, den make Moses blow dem for air for di king front.
EXO 9:9 Di ashes go skata like dust for Egypt and e go kause boil wey go turn to sore for Egypt pipol and dia animals body.”
EXO 9:10 So dem gada di ashes from di firewood kon stand for Fero front. Den Moses blow di ashes for air and e kon turn to boil for both Egypt pipol and dia animals body.
EXO 9:11 Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own.
EXO 9:12 But God still make Fero heart strong and e nor gri listin to dem, just as Oga God sey e go bi.
EXO 9:13 God kon tell Moses, “Make yu get up for early morning go meet Fero kon tell am, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go woship mi!
EXO 9:14 Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.
EXO 9:15 If to sey I take sickness attack yu and yor pipol, all of una for don die finish.
EXO 9:16 Dis na di rizin why I neva kill yu. I just won show yu my pawa, so dat pipol go praiz my name for evriwhere for di eart.
EXO 9:17 Yu still dey karry body up and yu nor gri free my pipol.
EXO 9:18 So, by dis time tumoro, I go make strong ice-blok rain wey dem dey koll ‘hail’, fall as e neva fall for Egypt before.
EXO 9:19 So naw, make yu go tell yor pipol make dem gada all dia animal and evritin wey dem get komot from di field kon kover dem for house. Dis na bikos anybody wey di ice-blok rain fall meet for outside, go die!” ’ ”
EXO 9:20 Doz wey bi Fero savants wey dey fear God word kon rush go gada dia savant and animals enter house.
EXO 9:21 But di rest ones wey nor bilive Oga God word kon leave dia savant and kattles for outside.
EXO 9:22 Den God tell Moses, “Stresh yor hand go heaven make di ice-blok rain fall for Egypt; on-top di pipol, animals and evritin wey dey grow for Egypt.”
EXO 9:23 Wen Moses stresh di stik wey dey en hand go heaven, God kon send tonda and plenty ice-blok and fire kon dey fall for groun: so Oga God make ice-blok fall like rain for Egypt.
EXO 9:24 Fire wey mix with ice-blok kon dey fall too. Di rain strong well-well and Egypt pipol neva ever si dis kind rain before.
EXO 9:25 Di ice-blok distroy evritin wey dey di field, both pipol and animals. Di rain distroy evritin wey dey grow for di field kon break di trees to pieces.
EXO 9:26 But di ice-blok rain nor fall for Goshen land where Israel pipol dey stay.
EXO 9:27 So Fero send for Moses and Aaron kon tell dem, “Dis time I gri sey I don sin! God dey holy and na mi and my pipol dey guilty.
EXO 9:28 So make una help mi beg God, bikos di strong tonda and ice-blok too mush and I go free una and una nor go stay here again.”
EXO 9:29 Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world.
EXO 9:30 But I know sey yu and yor savants neva still dey fear God.”
EXO 9:31 (For dis time, di plant wey dem dey koll flax and barley don skata and die, bikos di barley don ripe and di flax dem just dey won get flower.
EXO 9:32 But e nor get any wheat wey distroy, bikos dem neva grow kom out.)
EXO 9:33 So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall.
EXO 9:34 Wen Fero si sey di rain, ice-blok and di tonda don stop, e kon still sin again: both en and en savants kon get strong heart.
EXO 9:35 So Fero heart still dey strong and e nor gri release Israel pipol, just as God tok.
EXO 10:1 Den God kon tell Moses, “Make yu go meet Fero, bikos I don make en and en savants heart strong, so dat I go fit show dem all dis my mirakles.
EXO 10:2 All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”
EXO 10:3 So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!
EXO 10:4 But if yu nor gri let dem go, I go make lokust full yor kountry tumoro.
EXO 10:5 Di lokust dem go plenty well-well kon kover evriwhere and nobody go si ordinary groun. Dem go chop all di tins wey remain from wetin di ice-blok rain distroy and dem go chop all di trees for field.
EXO 10:6 Di lokust dem go full yor house, yor savants house and all Egypt pipol house and e go plenty pass wetin una papa and grand-grand papa don ever si since wen dem dey di land kon rish today!’ ” Den Moses turn kon waka leave Fero.
EXO 10:7 Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”
EXO 10:8 So dem bring Moses and Aaron kom back kon si Fero and e tell dem, “Make una go serve di Oga una God. But na wish pipol dey follow una go?”
EXO 10:9 Moses ansa am, “Wi go-go with awa yong and old pipol; all awa shidren and all awa animals, bikos wi dey travel go do sakrifice to take honor di Oga awa God.”
EXO 10:10 Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!
EXO 10:11 So make only di men go serve Oga God, bikos dat na wetin yu wont.” Den Fero drive Moses and Aaron komot for en front.
EXO 10:12 God tell Moses, “Make yu stresh yor hand face Egypt, so dat di lokust go kom kover evriwhere and dem go chop all di plants wey dey grow wey di ice-blok distroy remain.”
EXO 10:13 So Moses stresh di stik wey dey en hand face Egypt. At wons, Oga God make one strong breeze from east blow kom Egypt, both for day and nite. For morning, di breeze from east don karry lokust enter di land.
EXO 10:14 Di lokust kover evriwhere for Egypt, plus di arias wey dey near der. Di wahala strong well-well and dem neva si any lokust like dat before and dem nor go ever si any lokust like dat again.
EXO 10:15 Di lokust kover di groun kon make am black, den chop all di plants and fruits wey dey for di tree wey di ice-blok distroy remain. No leaf remain for di tree and all di plants and grass, die finish for Egypt.
EXO 10:16 Den Fero kwik-kwik sey make dem koll Moses and Aaron and e tell dem, “I don sin against di Oga una God and against una!
EXO 10:17 Make una forgive mi for dis last time and pray to di Oga una God, so dat E go remove dis sofa from mi.”
EXO 10:18 So Moses komot from Fero front kon go pray to Oga God.
EXO 10:19 Den God send anoda strong breeze from di sea and e karry all di lokust enter di Red Sea. No lokust remain for Egypt again.
EXO 10:20 But God still make Fero heart strong and e nor gri free Israel pipol.
EXO 10:21 Den God tell Moses, “Make yu stresh yor hand go heaven, so dat darkness go kover Egypt and dem go feel am, bikos e go tick well-well.”
EXO 10:22 So Moses stresh en hand go heaven and for three days, tick darkness kon dey evriwhere for Egypt.
EXO 10:23 Nobody fit si each oda and nobody fit stand up komot for where e dey for three days. But Israel pipol get lite for where dem dey.
EXO 10:24 Den Fero send for Moses kon tell am, “Make una go serve di Oga una God, both una and una family, but una animals go dey here for Egypt.”
EXO 10:25 But Moses ask am, “Yu go give us di animals wey wi go take do sakrifice and burnt ofrin to di Oga wey bi awa God?
EXO 10:26 All awa animal must go with us and no one go remain. Wi must take di animals go serve awa God. Until wi rish der, wi nor go fit know wetin to take serve awa God.”
EXO 10:27 But God still make Fero heart strong and e nor gri free dem.
EXO 10:28 So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”
EXO 10:29 Moses ansa, “Make e bi as yu tok! I nor go si yor face again.”
EXO 11:1 God kon tell Moses, “I go bring di last wahala to take ponish Fero and Egypt pipol and afta dis one, e go free una. E go drive una komot with evritin wey una get.
EXO 11:2 So make yu go tell Israel pipol make dem ask dia neighbour for silva and gold.”
EXO 11:3 (Naw, God don make Egypt pipol love Israel pipol. Even sef Moses kon bi one very big pesin for Egypt and Fero savants and Egypt pipol dey respet am.)
EXO 11:4 Moses sey, “Oga God sey for mid-nite, I go waka pass evriwhere inside Egypt
EXO 11:5 and all di first-born son for Egypt, go die. I go start from Fero first-born wey go take-ova en papa throne, go rish di first-born wey en slave girls wey dey grind korn born and all di first-born among en animals.
EXO 11:6 Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again.
EXO 11:7 But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol.
EXO 11:8 All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.
EXO 11:9 God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.”
EXO 11:10 So Moses and Aaron do all dis wonders wey Fero si, but God make Fero heart strong, so dat e nor go let Israel pipol komot from Egypt.
EXO 12:1 God tell Moses and Aaron for Egypt,
EXO 12:2 “Dis mont na di first mont for di year for una.
EXO 12:3 Make una tell Israel pipol sey, ‘For di tent day for dis mont, all di men go choose one yong sheep or goat for en family.
EXO 12:4 If en family too small to chop one full animal, en and en neighbour wey dey stay near am go share one animal akordin to di pipol and how dem go fit chop rish.
EXO 12:5 Make di animal wey una choose dey okay; animal wey neva pass one year and e must bi man sheep or goat wey nor dey cripple or get sickness.
EXO 12:6 “ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals.
EXO 12:7 Dem go take some of di blood put for di two door post and on-top di door for all di house wey dem go for chop di animal.
EXO 12:8 For dat same nite, dem go roast and chop di meat with bitter leaf and bread wey nor get yist.
EXO 12:9 Make una nor chop raw or meat wey dem boil, but make una roast am for fire well-well with en head, leg and all di parts for en body.
EXO 12:10 Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
EXO 12:11 “ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova.
EXO 12:12 Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.
EXO 12:13 Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.
EXO 12:14 Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.
EXO 12:15 “ ‘For seven days, una must chop bread wey nor get yist. So for di first day, una must remove di yist wey dey una house, bikos if anybody chop bread wey get yist from di first day go rish di sevent day, I go kill-am.
EXO 12:16 For di first and sevent day, make una gada kom woship mi. Nobody go work for doz days, escept una won do wetin una go chop.
EXO 12:17 “ ‘So make una kontinue to celebrate dis feast, bikos na di day wey I take una komot from Egypt and una go dey celebrate am forever.
EXO 12:18 For evening for di fourteent day for di first mont, make una chop bread wey nor get yist, until di twenty-first day evening for di same mont.
EXO 12:19 Yist must nor dey una house for seven days and anybody wey chop anytin wey get yist, nor go dey among Israel kommunity again. Weda na strenja or Israel pesin wey dem born for di land.
EXO 12:20 Make una nor chop anytin wey get yist and anywhere wey una go stay, una must nor chop bread wey get yist.’ ”
EXO 12:21 Den Moses gada di eldas for Israel kon tell dem, “Make all di family kill one yong sheep or goat take celebrate di Passova.
EXO 12:22 Make una deep di plant wey dem dey koll hyssop inside di blood, den take di blood rub di two pole for di door and di one wey cross dem for up. And make anybody nor komot from inside en house until morning.
EXO 12:23 Bikos Oga God go waka pass Egypt kon kill pipol, but wen E si di blood for di up and two side for una door, E go waka pass and E nor go enter una house kon kill una.
EXO 12:24 “Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever.
EXO 12:25 And wen una don enter di land wey di Oga una God go give una, just as E tok, una must do dis ofrin.
EXO 12:26 Wen una shidren ask una sey, ‘Wetin dis ofrin mean?’
EXO 12:27 Den una go ansa, ‘Na di Passova sakrifice for di Oga awa God, wen E kill Egypt pipol kon save wi and awa family.’ ” Den Israel pipol bow woship
EXO 12:28 kon do as God kommand dem thru Moses and Aaron.
EXO 12:29 Dat nite, Oga God kill all di first-born son for Egypt and na from Fero first-born go rish doz wey dey prison and di animals first-born.
EXO 12:30 Fero with all en savants and evribody for Egypt wake-up for nite bigin kry well-well, bikos e nor get any house where pesin nor for die.
EXO 12:31 Dat same nite, di king kon sey make dem go koll Moses and Aaron, den e tell dem, “Make yu and yor pipol komot from my kountry go woship di Oga una God, just as yu tok.
EXO 12:32 Make yu still take una sheep, goat and kattles follow body. But bless mi too.”
EXO 12:33 Egypt pipol bigin enkourage Israel pipol, so dat dem go kwik komot, bikos dem dey sey, “All of us go die finish, if una nor komot for here.”
EXO 12:34 So di pipol fill dia bakin pan with bread wey nor get yist, tie am join dia klot kon karry dem put for dia shoulder.
EXO 12:35 Israel pipol kon do as Moses tell dem. Dem ask Egypt pipol for silva, gold and klot.
EXO 12:36 God make Egypt pipol favor en pipol and dem kon give Israel pipol evritin wey dem wont. Like dis, Israel pipol karry all di propaty for Egypt follow body.
EXO 12:37 Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am).
EXO 12:38 Many strenjas still follow Israel pipol komot from Egypt with all dia sheep, goat and kattle.
EXO 12:39 Dem bake bread wey nor get yist with di bakin pan wey dem dey karry komot Egypt. Di bread nor get yist, bikos dem hurry dem komot from Egypt, so dem nor get time to prepare food for demsef.
EXO 12:40 Israel pipol stay for Egypt for four hundred and thirty years.
EXO 12:41 Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.
EXO 12:42 Na dat nite God take save dem komot from Egypt and dem go dey dedikate dat nite to God from one generashon go rish anoda.
EXO 12:43 So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food.
EXO 12:44 But any slave wey yu buy wey dem sekonsaiz, fit chop am.
EXO 12:45 Any strenja or worker wey dem hire must nor chop from am.
EXO 12:46 Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone.
EXO 12:47 Israel pipol must always dey celebrate dis feast.
EXO 12:48 “Any strenja wey dey stay with una wey like to celebrate Oga God Passova, dem must sekonsaiz dia men, den una must si dem as Israel pipol.
EXO 12:49 Anybody, weda dem born as Israel pesin or strenja wey dey stay with una, must obey dis law.”
EXO 12:50 So Israel pipol kon do as Moses and Aaron kommand dem.
EXO 12:51 For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.
EXO 13:1 God kon tell Moses:
EXO 13:2 “Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”
EXO 13:3 So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.
EXO 13:4 Una komot from Egypt for Abib mont.
EXO 13:5 Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.
EXO 13:6 For seven days, make una chop bread wey nor get yist and for di sevent day, una go do feast for di Oga una God.
EXO 13:7 Una go chop bread wey nor get yist for seven days and make una nor keep any bread wey get yist for una house.
EXO 13:8 “Make una tell una shidren for dat day sey, ‘All dis tins wey wi dey do so, na bikos of wetin awa God do for us wen wi komot from Egypt.’
EXO 13:9 Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.
EXO 13:10 Una must celebrate dis feast for di rite time for di year.
EXO 13:11 “Wen di Oga una God don take una enter Kanaan pipol land as E promise una and una grand-grand papa,
EXO 13:12 una must give all di first-born wey bi man, both human being and animals to Oga God.
EXO 13:13 Una fit take donkey first-born from God if una gi-am one lamb or yong goat. But if una nor kollect am back, una must break en neck. But una must buy una first son back.
EXO 13:14 “Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.
EXO 13:15 Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’
EXO 13:16 Dis matter go bi like sign for una hand and fore head, so dat una go remember as di Oga God take karry us komot from Egypt with en mighty pawa.”
EXO 13:17 Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
EXO 13:18 So God lead di pipol pass di wildaness wey face di Red Sea. And Israel pipol prepare demsef for war as dem dey komot from Egypt.
EXO 13:19 Moses pak Josef bones, bikos Josef don make Israel pipol swear wen e sey, “God go kom save una and una must karry my bones komot from dis place.”
EXO 13:20 So dem travel from Sukkot go Etam for di wildaness korna.
EXO 13:21 Naw, God dey lead dem with kloud for day time, den for nite, E dey lead dem with fire, so dat dem go fit travel both for day and nite.
EXO 13:22 Oga God nor remove di kloud for day time or di fire for nite.
EXO 14:1 Den God tell Moses,
EXO 14:2 “Make yu tell Israel pipol sey make dem go stay for Pi Hahirot wey dey between Migdol and di Red Sea opposite Baal Baal-Zefon.
EXO 14:3 Fero go tink sey Israel pipol konfuse kon dey waka up-and-down for di wildaness.
EXO 14:4 I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
EXO 14:5 Wen dem tell Fero sey Israel pipol don go, en heart and en savants heart kon turn against Israel pipol. So dem sey, “Wetin even make us do dis tin? Naw wey wi don free Israel pipol, na who go kon dey serve us?”
EXO 14:6 Di king kon ready en and en sojas shariot.
EXO 14:7 Den e take six hundred of en best shariot and all di horse for Egypt and di sojas wey go ride dem.
EXO 14:8 God make Fero heart strong well-well, so e kon porshu Israel pipol. Naw Israel pipol just komot Egypt with betta mind.
EXO 14:9 Egypt sojas porshu dem with all dia shariot and Fero shariot and dem katch Israel pipol for dia kamp for Pi Hahirot and Baal Baal-Zefon wey dey near di Red Sea near.
EXO 14:10 Israel pipol look up kon si Fero and Egypt sojas dey mash kom meet dem. Fear katch dem, so dem shaut kon kry to God.
EXO 14:11 Den di pipol tell Moses, “Na bikos grave nor dey Egypt, naim make yu bring us kom inside dis wildaness, so dat wi go die for here? Na wetin make yu karry us komot from Egypt?
EXO 14:12 Wi tell yu for Egypt sey, ‘Make yu leave us as wi dey serve Egypt pipol! E for betta sey wi dey serve Egypt pipol, dan to kom die inside dis wildaness o-o!’ ”
EXO 14:13 Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
EXO 14:14 God go fight for una, so make una nor worry.”
EXO 14:15 Den Oga God tell Moses, “Wetin make yu dey kry to mi? Tell di pipol make dem move go front.
EXO 14:16 But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.
EXO 14:17 But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.
EXO 14:18 Den Egypt pipol go know sey na mi bi God wen I don kollect my glory for wetin I go do Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.”
EXO 14:19 God angel wey dey lead Israel pipol kon go dia back and di kloud move komot from dia front go dia back.
EXO 14:20 Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
EXO 14:21 So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.
EXO 14:22 So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.
EXO 14:23 All Fero shariot and doz wey dey ride dem kon porshu Israel pipol enter di Red Sea for dry land.
EXO 14:24 As day won break, God look Egypt sojas thru di fire and di kloud kon make dem konfuse.
EXO 14:25 E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
EXO 14:26 God kon tell Moses, “Make yu stresh yor hand face di sea, so dat di wota go fall kon kover all Egypt sojas, dia shariot and doz wey dey ride dem.”
EXO 14:27 So Moses stresh en hand face di sea and wen morning rish, di sea don go back to di way e bi before. For dis time, Egypt sojas try to run from di wota, but God kill all of dem inside di sea.
EXO 14:28 Di wota fall kover di shariot with doz wey dey ride dem and all Fero sojas wey porshu Israel pipol enter di sea, kon die.
EXO 14:29 But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side.
EXO 14:30 So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside.
EXO 14:31 Wen Israel pipol si how di Oga dia God take fight Egypt pipol with en mighty pawa, dem kon dey fear am. So, dem kon bilive God and en savant, Moses.
EXO 15:1 Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea.
EXO 15:2 Na God bi my pawa and Savior. Dis na my God and I go praiz am. My grand-grand papa dem God and I go sing about how E great rish.
EXO 15:3 Awa Oga sabi fight war, na God bi en name.
EXO 15:4 E trow Fero shariot, all en sojas and strong ofisas inside di Red Sea kon kill dem.
EXO 15:5 Di deep sea kover dem; dem sink go bottom like stone.
EXO 15:6 My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces.
EXO 15:7 With yor pawa as King, Yu don fall doz wey stand to fight Yu. Yu burn dem like dirty, bikos Yu dey vex.
EXO 15:8 Yu breath from yor nose and di wota kon full. Di river wey dey flow kon stand like wall and di part wey deep pass for di sea, kon strong.
EXO 15:9 Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’
EXO 15:10 But Yu breath from yor nose and di sea swallow dem. Dem sink like stone inside di big sea.
EXO 15:11 My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?
EXO 15:12 Yu stresh yor rite hand and di groun swallow dem.
EXO 15:13 With yor true love, Yu go lead di pipol wey Yu save and with yor pawa, Yu go show dem di way to yor holy land.
EXO 15:14 Oda kountries go hear wetin happen kon fear Yu; betta fear go hold Filistia pipol.
EXO 15:15 Den Edom leaders go fear well-well; di strong men for Moab go dey shake and di pawa wey Kanaan pipol get, go vanish.
EXO 15:16 Betta fear go katch dem and with yor great pawa, dem go bi like stone kon dey fear until di pipol wey Yu save, go waka pass.
EXO 15:17 Yu go take dem enter inside di land kon plant dem for yor mountin; di place where Yu choose as yor house, bikos na Yu wey bi my Oga God, build am as yor own Temple.
EXO 15:18 God go reign forever and ever!
EXO 15:19 “Wen Fero men with dia shariot enter di sea, Oga God kon make wota swallow dem, but Israel pipol waka pass for dry groun.”
EXO 15:20 Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
EXO 15:21 Miriam sey, “Make wi sing to di Oga awa God, bikos E don win big war; E trow di horse and doz wey dey ride am inside di sea.”
EXO 15:22 Den Moses lead Israel pipol from di Red Sea enter Shur wildaness. Dem travel inside di wildaness for three days and dem nor si wota drink.
EXO 15:23 Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.)
EXO 15:24 So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?”
EXO 15:25 Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith.
EXO 15:26 God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”
EXO 15:27 Den dem go Elim where dem si twelf well and seventy palm tree. So dem kon stay near di wota.
EXO 16:1 Wen Israel pipol komot from Elim, dem kon go Sin Wildaness wey dey between Elim and Sinai for di Fifteent day for di sekond mont afta dem don komot from Egypt.
EXO 16:2 So evribody for Israel kon dey komplain give Moses and Aaron inside di wildaness.
EXO 16:3 Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”
EXO 16:4 Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment.
EXO 16:5 But for di sixt day, make dem gada doubol of wetin dem bin dey gada.”
EXO 16:6 So Moses and Aaron tell Israel pipol, “Dis evening, una go know sey na God take una komot from Egypt.
EXO 16:7 For morning, una go si God glory, bikos E don hear as una dey komplain against am. Na-im una dey komplain to, nor bi wi wey just bi ordinary human being.”
EXO 16:8 So Moses sey, “Wen God give una meat chop for evening and bread for morning, den una go know sey, E don hear all una komplain. Wetin wi bi sef? Una komplain nor bi against us, but na against God.”
EXO 16:9 Den Moses tell Aaron sey make e tell Israel pipol make dem kom meet God, bikos E don hear all dia komplain.
EXO 16:10 As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.
EXO 16:11 Den God tell Moses:
EXO 16:12 “I don hear Israel pipol komplain, so go tell dem, ‘Una go chop meat for evening kon chop bread for morning until una beleful, den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God.’ ”
EXO 16:13 For evening, kwail bird kon fall full groun for di kamp and for morning dew gada evriwhere for di kamp.
EXO 16:14 Wen di dew don komot, small-small round tins wey white like ice-blok still dey groun for di wildaness.
EXO 16:15 Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi. Den Moses tell dem, “Na di bread wey God send kom give una.
EXO 16:16 Dis na wetin God kommand: ‘Make evribody take wetin e fit chop. One omer for one pesin; den una go gada akordin to di pipol wey dey una house.’ ”
EXO 16:17 So Israel pipol do as God kommand. Some gada plenty, while odas gada small.
EXO 16:18 Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.
EXO 16:19 So Moses tell dem, “Make nobody keep dem till tumoro.”
EXO 16:20 But some nor gri listin to Moses, bikos dem still keep some till di next day. Di food wey dem keep kon get worm and e start to smell, so Moses kon dey vex for doz pipol.
EXO 16:21 So Israel pipol kon dey gada am evry morning; each pesin akordin to wetin e fit chop finish and wen sun don make evriwhere hot, di rest food go melt.
EXO 16:22 For di sixt day, dem gada doubol food, two omer for one pesin. Den di leaders for di kommunity kom ask Moses, “Why e bi like dat.”
EXO 16:23 Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
EXO 16:24 So dem keep am till di next day, just as Moses kommand and e nor spoil, smell or get worm.
EXO 16:25 Moses kon tell dem, “Make una chop am today, bikos today na awa God Sabat Day and una nor go si food chop for di field.
EXO 16:26 Una go si gada for six days, but for di sevent day wey bi di Sabat Day, una nor go si any one gada or pick.
EXO 16:27 “For di sevent day, some pipol among una go won go gada, but dem nor go si anytin gada.”
EXO 16:28 So God tell Moses, “How long e go take before dis pipol go start to obey my kommandment?
EXO 16:29 Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.”
EXO 16:30 So di pipol rest for di sevent day.
EXO 16:31 Israel pipol koll di food “Manna.” Bikos e bi like korianda seed and e white and dey taste like biscuit wey dem do with honey.
EXO 16:32 Den Moses sey, “Dis na wetin God kommand: ‘Make una keep one full omer wey go dey from one generashon go rish anoda, so dat dem go si di food wey I dey give una for di wildaness, afta I take una komot from Egypt.’ ”
EXO 16:33 Moses kon tell Aaron, “Make yu measure one omer for manna with one kontaina, den put am for where Oga God Spirit dey, so dat E go take am dey remember di generashon wey dey kom for back.”
EXO 16:34 Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.
EXO 16:35 So Israel pipol chop manna for forty years until dem rish Kanaan land.
EXO 16:36 (If yu divide efah into ten, na one part bi one omer.)
EXO 17:1 Israel pipol kon start to travel from Sin Wildaness, just as Oga God kommand dem. Dem stay for Refidim, but di pipol nor si wota to drink for der.
EXO 17:2 So dem komplain give Moses, “Make yu give us wota drink!” Moses ansa dem, “Wetin make una dey kworel with mi? Why una dey test God?”
EXO 17:3 But di pipol dey hongry to drink wota, so dem still komplain, “Wetin make yu take us komot from Egypt? Na to kill wi, awa shidren and awa animals with honga?”
EXO 17:4 Den Moses kry to God, “Wetin I go do with dis pipol? Bikos if e worse pass like dis, di pipol go stone mi die!”
EXO 17:5 God tell Moses, “Take some among di eldas for Israel, with yor stik wey yu take nak River Nile, den make yu lead di pipol.
EXO 17:6 I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.
EXO 17:7 Moses koll di place Massah and Meribah, bikos Israel pipol komplain and test God wen dem sey, “Yu sure sey, ‘God dey with us?’ ”
EXO 17:8 Amalek pipol kon attack Israel pipol for Refidim.
EXO 17:9 So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”
EXO 17:10 So Joshua fight Amalek pipol just as Moses tell am, den Moses, Aaron and Hur kon go top of di hill.
EXO 17:11 Anytime Moses karry en hand go up, Israel pipol go dey win, but wen e bring en hand kom down, Amalek pipol go dey win.
EXO 17:12 Wen Moses hands don taya am, Aaron and Hur gi-am stone make e sidan, den dem kon hold en hand; one pesin for di rite and anoda pesin for di left. So en hand kon dey up until evening.
EXO 17:13 Like dis, Joshua win Amalek pipol and dia sojas.
EXO 17:14 Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.”
EXO 17:15 So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,”
EXO 17:16 bikos e sey, “Dem karry dia hand face God throne, so dat God go dey fight Amalek pipol forever.”
EXO 18:1 Jetro, Moses wife papa, wey bi priest for Midian kon hear all di tins wey God don do for Moses and Israel pipol. How God take free dem from Egypt.
EXO 18:2 So Jetro kon bring Zipporah, Moses wife wey Moses bin live for Midian
EXO 18:3 and en two sons, Gershom (bikos Moses sey, “I bi strenja for anoda land”);
EXO 18:4 and Elieza (wey mean, “Na awa papa God help and save mi from Fero”).
EXO 18:5 Jetro karry Moses wife and en two sons go meet Moses for inside di wildaness, where dem dey for God mountin.
EXO 18:6 But e first send message to Moses sey, “I dey kom with yor wife and yor two pikin.”
EXO 18:7 So Moses go meet en wife papa, bow kon kiss am. Dem greet each oda kon enter house.
EXO 18:8 Moses tell en wife papa evritin wey God do to Fero and Egypt pipol, bikos of Israel pipol; di tins wey dem sofa for road and how God take save dem.
EXO 18:9 Den Jetro kon dey happy for all di good tins wey Oga God do for Israel pipol wey E save from Egypt.
EXO 18:10 Jetro kon sey, “Make una bless Oga God wey save una from Fero and Egypt pipol. Di God wey save en pipol from sofa.
EXO 18:11 Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”
EXO 18:12 Den Jetro sakrifice and burn ofrin for God. So Aaron and all di eldas for Israel join Moses wife papa chop di food for God present.
EXO 18:13 Di next day, Moses sidan to judge kase and pipol gada round am from morning till evening.
EXO 18:14 Wen en wife papa si all di tins wey Moses dey do for di pipol, e kon ask am, “Why yu dey do all dis tins for dis pipol? Na only yu sidan dey judge from morning go rish evening?”
EXO 18:15 Moses ansa am, “Dis pipol dey kom meet mi, so dat dem go know wetin God tok.
EXO 18:16 Wen dem get any matter, di pipol go kom and I go judge and let dem know God kommand, en rules and law.”
EXO 18:17 Den Moses wife papa tell am, “Di tins wey yu dey do so good o-o.
EXO 18:18 But yu go taya one day; both yu and di pipol wey dey with yu, bikos dis tin too heavy for yu and only yu nor go fit karry di load.
EXO 18:19 So, I go advise yu and make God dey with yu. Na yu go stand before God for dis pipol kon take dia matter go meet am.
EXO 18:20 Make yu tish dem God kommand and law. And make dem know how to live and work as God wont am.
EXO 18:21 But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.
EXO 18:22 Dem go judge di pipol and any matter wey big pass dem, dem go bring am kom meet yu, but na dem go dey judge all di small-small matter. Like dis, dem go follow yu share for di load.
EXO 18:23 If yu do dis tin and if na God really kommand yu, den di work go eazy for yu and di pipol go happy go house.”
EXO 18:24 So Moses listin to en wife papa kon do all di tins wey e tell am.
EXO 18:25 Moses choose men wey fit do di work among Israel pipol kon make dem oga ova di pipol. Some dey rule tazons, odas hundred, some fifty and some ten.
EXO 18:26 Dem always dey judge di pipol and any matter wey dem nor fit handle, dem go take am go meet Moses. But na only dem dey judge all di small-small matter.
EXO 18:27 Den Moses escort Jetro, en wife papa as e dey go back to en house for Midian.
EXO 19:1 Israel pipol rish Sinai Wildaness for di first day for di third mont afta dem komot from Egypt.
EXO 19:2 Afta dem travel komot from Refidim, dem rish Sinai Wildaness kon stay for di mountin front.
EXO 19:3 God koll Moses from di mountin kon tell am, “Dis na wetin yu go tell Jakob house and Israel pipol:
EXO 19:4 ‘Una don si wetin I do Egypt pipol. Una si as I take karry una for eagle feada kon bring una kom meet mi.
EXO 19:5 And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.
EXO 19:6 Una go bi my kingdom priests and holy nashon wey dem dedikate give mi.’ Dis na wetin yu go tell Israel pipol.”
EXO 19:7 So Moses koll all di eldas for Israel kon tell dem wetin Oga God kommand am.
EXO 19:8 All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.
EXO 19:9 Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.” Moses tell God wetin di pipol tok.
EXO 19:10 God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot
EXO 19:11 and ready for di third day, bikos for dat third day, I go kom from Mount Sinai and all di pipol go si mi.
EXO 19:12 Tell evribody where dem go waka rish kon sey, ‘Make anybody nor klimb di mountin or tosh en korna. Anybody wey tosh di mountin, go die!
EXO 19:13 Nobody go tosh di pesin, but dem go stone am or shot am with arrow. E must die, weda na human being or animal.’ Wen dem blow di ram horn, di pipol go-go di mountin front.”
EXO 19:14 Den Moses kom down from di mountin go meet di pipol. E santify and make dem wosh dia klot.
EXO 19:15 E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”
EXO 19:16 For morning for di third day, tonda, lite and one tick kloud kon appear on-top di mountin, so dem blow di horn well-well. Fear katch all di pipol for di kamp.
EXO 19:17 Moses take di pipol komot from di kamp go meet God and dem stand for di mountin front.
EXO 19:18 Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.
EXO 19:19 Wen dem blow di horn well-well, Moses start to tok and God kon dey ansa am.
EXO 19:20 God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
EXO 19:21 God tell Moses, “Make yu go down go warn di pipol sey make dem nor waka pass where yu tell dem, bikos dem won si wetin dey happen and anybody wey nor listin to yu, go die.
EXO 19:22 Even di priests wey dey near mi, make yu tell dem make dem wosh demsef well-well, if not I go distroy dem too.”
EXO 19:23 Moses kon tell God, “Di pipol nor go fit kom Mount Sinai, bikos Yu really warn us sey, ‘Di mountin na where dey holy, so make una nor waka near am.’ ”
EXO 19:24 But God tell Moses, “Make yu go down, den kom back again with Aaron, but nor let any priests or di pipol waka pass or near di mountin, bikos I go ponish dem.”
EXO 19:25 So Moses go down go meet di pipol kon tell dem wetin God tok.
EXO 20:1 God kon sey:
EXO 20:2 “Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.
EXO 20:3 Make una nor serve any oda God apart from mi.
EXO 20:4 Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota.
EXO 20:5 Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
EXO 20:6 But I go show my love to many generashon, bikos dem love and keep my kommand.
EXO 20:7 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.
EXO 20:8 Make una remember to keep di Sabat Day holy.
EXO 20:9 Una get six days to do all una work,
EXO 20:10 but for di sevent day wey bi di Oga una God Sabat Day, make nobody do any work; both una, una shidren, una savants, una animals or di strenjas for una kountry.
EXO 20:11 Bikos na six days God take make heaven, eart and all di tins wey dey inside dem and E rest for di sevent day. So God bless di Sabat Day kon make am holy.
EXO 20:12 Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
EXO 20:13 Make una nor kill.
EXO 20:14 Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
EXO 20:15 Make una nor tif.
EXO 20:16 Make una nor lie for una neighbour head.
EXO 20:17 Make una nor get long-trot for una neighbour propaty; en wife, savants, melu, donkey or anytin wey bi en own.”
EXO 20:18 Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.
EXO 20:19 Dem kon tell Moses, “Make yu tok to us and wi go listin, but make yu nor let God tok to us, so dat wi nor go die.”
EXO 20:20 Moses tell di pipol, “Make una nor fear, God just kom test una, so dat una go fear and always dey obey en kommand.”
EXO 20:21 Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
EXO 20:22 God tell Moses, “Make yu go tell Israel pipol: ‘Una don si by unasef sey, I dey tok to una from heaven.
EXO 20:23 So make una nor use silva or gold take make any oda god join mi.
EXO 20:24 “ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.
EXO 20:25 And if una take stone build altar for mi, una must nor use stone wey dem kut, bikos if una kut di stones, una don spoil di altar bi dat.
EXO 20:26 Make una nor build altar wey get step, so dat nobody go si una nakednes wen una dey klimb kon offa sakrifice give mi.’ ”
EXO 21:1 “Naw, dis na di laws wey yu go tell Israel pipol:
EXO 21:2 “If una buy any Hibru slave, e go serve una for six years, but e go dey free for di sevent year and e nor go pay anytin.
EXO 21:3 If di slave neva marry before e kom, na only en go komot, but if e don marry before e kom, di slave go komot with en wife.
EXO 21:4 “If na en oga gi-am wife and en wife born shidren, den na en oga go get di wife and di shidren, so na only di slave go-go.
EXO 21:5 But if di slave sey, ‘I love my oga, my wife and shidren; I nor go-go,’
EXO 21:6 den di oga go take am go meet doz wey dey judge. Dem go bring am kom di town gate kon put hole for di slave ear and di slave go serve en oga forever.
EXO 21:7 “If anybody sell en dota as slave, di girl nor go-go like man slave.
EXO 21:8 If di girl nor make belle sweet en oga wey buy am, den di oga go let am go. E nor get rite to sell am give strenjas, bikos na di oga break di kontract with am.
EXO 21:9 If e give di slave to en son as wife, e go trit di slave like en own dota.
EXO 21:10 If di man kon marry anoda wife, e must kontinue to give en first wife food, klot and evritin wey e nid as wife.
EXO 21:11 And if e nor fit give di girl dis three tins, e must free am and di girl nor go pay anytin.”
EXO 21:12 “Anybody wey nak and kill anoda pesin, dat pesin must die too.
EXO 21:13 But if na by mistake, den e go eskape go di place where I go choose and e go dey save for der.
EXO 21:14 Like dis too, if anybody use wayo take kill en neighbour, den una go take am komot from my altar go kill.
EXO 21:15 “Anybody wey beat en papa or mama, dem must surely kill-am.
EXO 21:16 “Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.
EXO 21:17 “Anybody wey do or trit en papa or mama anyhow, dem must kill-am.
EXO 21:18 “If two pipol fight and one among dem nak en sekond with stone or with en hand and e nor die, but e sick
EXO 21:19 and leta e kon stand up waka by ensef, den di pesin wey nak am, don dey innocent, but e go pay di pesin wey e wound all di time wey e don waste kon make sure sey en body strong.
EXO 21:20 “Anybody wey nak en savant, weda na man or woman savant with stik and e die, dem must ponish dat pesin.
EXO 21:21 But if di savant wey wound nor die afta one or two days, dem nor go ponish en owner, bikos e nor luz anytin.
EXO 21:22 “If two man dey fight and one mistakingly nak woman wey get belle and e kon born di pikin before nine monts, but e nor too wound, dem go ponish am akordin to wetin di woman husband ask for and e go pay anytin wey kourt sey make e pay.
EXO 21:23 But if di wound sirious and di woman kon die, den dem must kill who kill di woman and
EXO 21:24 na dat one bi eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.
EXO 21:25 Who burn pesin, dem go burn am too. Who wound pesin, dem go wound am too and who beat pesin, dem go beat am too.
EXO 21:26 “If anybody blind en savant eye, di man must free di savant, bikos of di eye wey e blind.
EXO 21:27 And if di man nak en savant tit komot, e must let am go free, bikos of di tit wey komot.”
EXO 21:28 “If pesin melu kill pesin, den dem go stone di melu die; nobody go chop di meat and dem nor go ponish di owner.
EXO 21:29 But if di melu dey always take en horn wound pipol and dem don warn di owner before and e nor do anytin koncerning di matter, before di melu kon kill pesin, dem must stone di melu die kon kill di owner too.
EXO 21:30 But if dem put prize for di owner head to save en life, den e go pay di full amount.
EXO 21:31 “If di melu take en horn wound pesin pikin, dem go judge am like di oda ones.
EXO 21:32 If di melu take en horn wound pesin savant, di owner must pay three shekel for silva and pipol go stone di melu die.
EXO 21:33 “If anybody dig pit for groun and e nor kover am and one melu or donkey fall enter,
EXO 21:34 di pesin wey get di pit must pay for di animal. E must pay to di owner, den di animal wey don die, go bi en own.
EXO 21:35 “If one man melu wound en neighbour melu and e die, den di two pipol go sell di melu wey dey alive kon share di money and dem go still share di melu wey die too.
EXO 21:36 Or if pipol know sey di melu dey always attack odas and dem tell di owner and e nor do anytin koncerning di matter, e must use di melu take pay, den di one wey don die, go bi en own.”
EXO 22:1 “If pesin tif one melu or sheep kon kill or sell am, e must use five kattle take pay for di melu and four sheep, for di sheep wey e sell or kill.
EXO 22:2 “If dem katch tif dey enter pesin house kon nak am die, en blood nor go dey anybody head.
EXO 22:3 “But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head. “Tif wey dem katch must pay evritin wey e tif. If e nor get anytin, den dem go sell am take pay for wetin e tif.
EXO 22:4 If dem si wetin e tif for en hand; weda na melu, donkey or sheep and di animal neva die, di tif must pay doubol.
EXO 22:5 “Anybody wey allow en animals wey dey chop grass for field go chop wetin anoda man plant for en farm, e must pay back with wetin good pass for en own farm.
EXO 22:6 “If fire dey burn for pesin farm kon spread and distroy plant for anoda pesin farm, di pesin wey start di fire go pay evritin wey distroy.
EXO 22:7 “If pesin give en neighbour money or propaty to keep for am and dem kon tif di tin for di man house, if dem katch di tif, e must pay doubol.
EXO 22:8 But if dem nor katch di tif, den di owner of di house go-go stand make dem judge am, weda naim take en neighbour propaty.
EXO 22:9 “If two pipol dey drag propaty, weda na melu, donkey, sheep, dress or any kind tin wey lost, di two of dem go kom meet di judge and anybody wey dem sey dey guilty, go pay doubol.
EXO 22:10 “If pesin give en neighbour one donkey, melu, sheep or any oda animal to keep for am and e kon die, wound or pesin tif am and e nor know,
EXO 22:11 di neighbour must swear to God sey, e nor get hand for di matter and di owner go asept en word and e nor go pay anytin.
EXO 22:12 But if dem tif am from am, e must pay di owner back.
EXO 22:13 If na wiked animal kill-am, di man go bring di meat pieces wey skata for groun to show and klear ensef and e nor go pay anytin.
EXO 22:14 “If pesin borrow animal from en neighbour and e kon wound or die wen di owner nor dey with am, di man must pay back.
EXO 22:15 If di owner dey with am, di man nor go pay anytin, bikos wetin e pay take hire am kover di money.
EXO 22:16 “If pesin deceive girl wey neva no man and e kon sleep with am, e must pay di bride prize kon marry di girl.
EXO 22:17 But if di girl papa nor gri gi-am to di man, di man must pay di prize wey dem dey pay for woman wey neva sleep with man before.
EXO 22:18 “Make una nor allow witch live.
EXO 22:19 “Anybody wey follow animal sleep, dem must kill-am.
EXO 22:20 “Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.
EXO 22:21 “Make una nor sofa or opress strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
EXO 22:22 “Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama.
EXO 22:23 If una sofa dem and dem kry kom meet mi, I go listin to dem.
EXO 22:24 I go vex and kill una with swod and una wifes go turn who nor get husband again; una pikin nor go get papa too.
EXO 22:25 “If una borrow money give poor pipol wey dey among una, make una nor do like sey una borrow money and make una nor add join di money wen dem won pay back.
EXO 22:26 If una take una neighbour klot as shorti, una must return am gi-am for evening,
EXO 22:27 bikos dat na di only klot wey una neighbour get to wear, so dat kold nor go katch am. E get any oda klot wey e go take sleep? And wen e kry kon meet mi, I go listin to am, bikos I dey pity for pesin well-well.
EXO 22:28 “Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.
EXO 22:29 “Make una give mi una plant and wine ofrin. “Una must give mi di first son wey una born.
EXO 22:30 “Una go still do like dis for una animals; dem fit dey with dia mama for seven days, but una go give dem to mi for di eight day.
EXO 22:31 “Una go bi my holy pipol, so make una nor chop any animal wey anoda animal kill for bush. Una must trow di animal meat give dogs.
EXO 23:1 “Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.
EXO 23:2 “Make una nor follow pipol do wiked tins; for inside yard, make una nor tok wetin una eye nor si, bikos plenty pipol dey tok am to take win dia kase
EXO 23:3 and make una nor lie against poor pesin for kourt.
EXO 23:4 “If una si una enemy melu or donkey wey waka lost, make una do evritin to make sure sey una return am to di owner.
EXO 23:5 Pesin wey hate una, if una si en donkey dey struggol bikos of di load wey e karry, make una nor waka pass, but make una help am.
EXO 23:6 “Make una nor give bad judgement to poor pesin for kourt.
EXO 23:7 “Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.
EXO 23:8 “Make una nor take bribe, bikos bribe dey blind pesin eye and spoil good pipol.
EXO 23:9 “Make una nor sofa or opress strenjas wey dey stay with una. Unasef know wetin e mean to bi strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
EXO 23:10 “For six years, make una plant and harvest wetin una plant.
EXO 23:11 But for di sevent year, una must allow di land rest and make una leave am, so dat poor pipol wey dey with una, go chop wetin grow for di land and di animals go chop wetin remain. Una must still do like dis for una vineyard and olive farm.
EXO 23:12 “Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.
EXO 23:13 “Make una do evritin wey I tell una and una nor go pray or swear to any oda god. Make I nor ever hear dia name for una mout.
EXO 23:14 “Evry year, una go celebrate three times to take honor mi.
EXO 23:15 For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand.
EXO 23:16 Make una still celebrate Harvest Feast wey bi di first fruit from evritin wey una plant for una land. Una go still celebrate Tanksgivin Feast wey bi di Shelta Feast wen di year end and for dis time, una go don gada all una harvest from di farm.
EXO 23:17 Three times for di year, all doz wey bi man go-go meet di Oga dia God.
EXO 23:18 “Make una nor offa my sakrifice blood with bread wey get yist. And di animal fat wey dem sakrifice, must nor remain till di next morning.
EXO 23:19 “Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”
EXO 23:20 “I go send one angel wey go protet una for front as una dey go and e go bring una kom di place wey I don prepare for una.
EXO 23:21 Make una listin and obey en vois; make una nor disobey am, bikos e nor go forgive una sins and e dey ansa my name too.
EXO 23:22 But if una obey am kon do all di tins wey I tell una, den I go bi enemy to doz wey bi una enemies and I go fight doz wey dey fight against una.
EXO 23:23 My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una.
EXO 23:24 Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.
EXO 23:25 “If una serve di Oga una God, E go bless una bread and wota kon remove all una sickness.
EXO 23:26 Evry woman go get shidren and doz wey get belle for una land, go must born pikin and una go get long life.
EXO 23:27 “I go put my fear for inside doz wey una go fight kon distroy dem; I go make all una enemies run from una.
EXO 23:28 I go send fear like ant go drive Hiv, Kanaan and Hit pipol komot before una go rish der.
EXO 23:29 I nor go take one year drive all of dem komot, so dat di land nor go turn to wildaness and wild animals nor go plenty for der.
EXO 23:30 Na small-small I go take drive dem komot until una go plenty kon take-ova.
EXO 23:31 Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.
EXO 23:32 “Make una nor enter kovenant with dem or with dia gods.
EXO 23:33 Make dem nor stay una land, so dat dem nor go make una sin against mi, bikos if una serve dia gods, I go distroy una.”
EXO 24:1 Den God tell Moses, “Make yu klimb kom meet mi; both yu, Aaron, Nadab, Abihu and di seventy eldas for Israel and wen una still dey far from where I dey, make una bow woship mi.
EXO 24:2 Na only Moses go kom near mi, but make di odas nor kom near and make di rest pipol nor klimb with am.”
EXO 24:3 So Moses tell di pipol wetin God tok and di pipol ansa, “Wi dey ready to do evritin wey di Oga awa God kommand.”
EXO 24:4 Den Moses rite di word wey God tok. For early morning, e build altar for under di mountin kon arrange and stand twelf stones; one for each of di twelf tribes.
EXO 24:5 E send some yong Israel men and dem go offa burn ofrin kon sakrifice one yong melu as peace ofrin to God.
EXO 24:6 Moses take half of di blood, pour am inside some basin, den e sprinkol di remainin half on-top di altar.
EXO 24:7 So e take di Kovenant Book kon read am make all di pipol hear and dem sey, “Wi dey ready to do and obey all di word wey di Oga awa God tok.”
EXO 24:8 So Moses take di blood and e sprinkol am for di pipol body kon sey, “Dis na di kovenant blood wey God don make with una akordin to dis word.”
EXO 24:9 Moses and Aaron, Nadab and Abihu and di seventy eldas for Israel kon go di mountin
EXO 24:10 and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.
EXO 24:11 But God nor distroy Israel leaders even doh dem si am kon chop and drink for en present.
EXO 24:12 Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”
EXO 24:13 So Moses and Joshua wey dey follow am kon go di mountin, den Moses klimb go meet God.
EXO 24:14 Before Moses go, e tell di eldas sey, “Make una wait for mi for here, until I go kom back. Aaron and Hur dey with una. Anybody wey get matter against anoda pesin, make e go meet dem and dem go setol am.”
EXO 24:15 Moses klimb go di mountin wey di kloud kover.
EXO 24:16 God glory dey on-top Mount Sinai and di kloud kover am for six days. For di sevent day, God kon koll Moses from inside di kloud.
EXO 24:17 From where di pipol dey, dem si God glory on-top di mountin like fire wey dey burn.
EXO 24:18 Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.
EXO 25:1 God kon tell Moses:
EXO 25:2 “Make yu tell Israel pipol make dem bring ofrin kon give mi. Yu go kollect di ofrin wey pipol go give from dia heart.
EXO 25:3 Na dis kind ofrin yu go kollect from dem: gold, silva, bronze,
EXO 25:4 fine linen, blue, purpol and red wool; klot wey dem make with goat hair,
EXO 25:5 ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood,
EXO 25:6 oil for di lite, spices for di anointin oil and for di incense wey get betta smell.
EXO 25:7 Onyx stones and oda tins wey dem go put for di priest garment and for di chest side.
EXO 25:8 Make dem build house for mi, so dat I go fit follow una stay.
EXO 25:9 Yu must make am with all di tins wey dem go put inside, just as I show yu.”
EXO 25:10 “Make dem build box with akasia wood wey long rish three fit nine inches and e go wide and high rish three fit.
EXO 25:11 Make dem kover inside and outside di box with pure gold.
EXO 25:12 Yu go make four gold ring kon put am for di four leg; two-two ring for each side.
EXO 25:13 Make some pole with akasia wood, kover am with gold
EXO 25:14 kon take di poles pass inside di rings wey dey di box side, so dat dem go fit use dem karry di box.
EXO 25:15 Di poles must dey inside di rings for di box; dem must nor take dem komot.
EXO 25:16 Di two small flat stones wey I go rite my kommandment put, yu go put dem inside di box.
EXO 25:17 “Make yu make one kover with pure gold; e go long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.
EXO 25:18 Yu go use gold wey dem melt take make two tins wey bi like angel wey get plenty feada kon put dem for di two korna for di box kover.
EXO 25:19 One among di angels wey dem make, go dey one end and di sekond one go dey di oda end.
EXO 25:20 Di angels go spread dia feada kon kover di box and di angels go face each oda dey look di box.
EXO 25:21 Yu go put di box kover on-top di box, den kon put di flat stones wey I go give yu, inside.
EXO 25:22 Den I go meet yu for der and from di box kover; between di two angels wey kover di box wey di kommandment dey, I go tell yu all di tins wey yu go kommand Israel pipol.
EXO 25:23 “Yu go use akasia wood take make one tabol; e go long rish three fit; wide like one fit six inches and e go high rish two fit three inches.
EXO 25:24 Yu go design am with pure gold.
EXO 25:25 Yu go make rim wey wide and round rish three inches kon do borda round di rim.
EXO 25:26 Yu go use gold make four rings kon put dem for di four korna wey di legs dey.
EXO 25:27 Di rings go dey near di rim and e go bi di poles wey dem go take dey karry di tabol.
EXO 25:28 Yu go use akasia wood take make all di poles kon design dem with gold, so dat dem go fit karry di tabol with dem.
EXO 25:29 Yu go make some plate, cup, jar and bowl wey dem go dey use for di wine ofrin. All dis tins, na pure gold yu go take make dem.
EXO 25:30 Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.
EXO 25:31 “Yu go make one lampstand with gold. Na gold wey dem melt yu go take make di bottom, en leg, cups, di small-small seeds and di flowers go bi di same with am.
EXO 25:32 Di lampstand go get six side: from en leg, three go dey one side and anoda three go dey di oda side.
EXO 25:33 Three cup wey dem shape like almond flower wey get small-small seeds, go dey di next branches and na di same tin e go bi for di six branches wey go kom out from di lampstand.
EXO 25:34 And for di lampstand, e get four cup wey dia shape resemble almond flower wey get small-small seeds and shine-shine.
EXO 25:35 One of di small-small seed go dey under all di six branches wey kom out from di lampstand.
EXO 25:36 Na di same pure gold wey yu melt, yu go take make dia small-small seed, branches and lampstand.
EXO 25:37 Yu go make seven lamp for di lampstand kon stand am, so dat e go give lite to di aria for en front.
EXO 25:38 Yu go use pure gold take make di lampstand korna and di tray.
EXO 25:39 Make yu use about seventy-five pound for pure gold take make di lampstand and di oda tins.
EXO 25:40 “Naw, make sure sey yu make dem, just as I show yu for di mountin.
EXO 26:1 “Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.
EXO 26:2 Each of di curtain go long rish forty-two fit and wide rish six fit.
EXO 26:3 Make yu join five curtain togeda.
EXO 26:4 Yu go take blue klot make ring for di curtain korna wey dey di end part for one set and like dis too, yu go make rings for outside di oda curtain korna for di sekond set.
EXO 26:5 Yu go make fifty ring for one curtain kon make anoda fifty ring for di curtain end wey dey di sekond set, so dat di rings go hold one anoda.
EXO 26:6 Den yu go make fifty gold hook take join di two set as one.
EXO 26:7 “Make yu make kover for di Tabanako with eleven curtain.
EXO 26:8 Di curtain go long rish forty-five fit kon wide rish six fit.
EXO 26:9 Den yu go join five curtain togeda kon join di remainin six togeda. Fold di nomba six curtain two times for di Tabanako front.
EXO 26:10 Yu go make fifty ring for di korna for di last curtain for one set and fifty ring for di korna for di curtain wey join di sekond set.
EXO 26:11 Yu go make fifty bronze hook kon put di bronze hooks inside di rings, den join di tent togeda, so dat evritin go form one kover.
EXO 26:12 Yu go hang di half tent curtain wey remain for di tent back.
EXO 26:13 Di one and half fit for di curtain lengt wey remain for di two side, yu go use am kover di two side.
EXO 26:14 Make yu take ram skin wey dem dye with red take make kover for di tent, den kover dis ram skin with fine leda.
EXO 26:15 “Yu go still take akasia wood do two stand as frame for di tent.
EXO 26:16 All di frame go long rish fifteen fit kon wide rish two fit three inches,
EXO 26:17 with two tins wey kom out, so dat dem go fit join di frames togeda. All di frames go bi di same.
EXO 26:18 So, make yu make di frame for di Tabanako and yu go make twenty for di sout-side
EXO 26:19 kon make forty silva wey go dey under di twenty frame; two silva go dey under one frame, bikos of di two tins wey dem go do kom out from am.
EXO 26:20 For di nort side for di tent, make yu make twenty frame
EXO 26:21 with dia forty silva bottom and two go dey under di next frame.
EXO 26:22 For di tent back wey face di west side, yu go make six frame.
EXO 26:23 Yu go make two frame for di tent korna for di two back-side.
EXO 26:24 For di two korna side, yu must doubol am for bottom, den kon finish di top as one ring and e go bi for di two korna.
EXO 26:25 So na eight frame go dey with dia sixteen silva bottom and two for di bottom go dey under di next frame.
EXO 26:26 “Den yu go take akasia wood take make some bar: five na for di frames for one side for di Tabanako
EXO 26:27 and five bar na for di frames for di oda side. Yu go still make five bar for di frames wey dey di back-side wey face west.
EXO 26:28 Di bar wey dey middle for where di oda frames dey, go long from one end go rish di oda.
EXO 26:29 Make yu kover all di frames with gold kon make dia rings with gold, den make one place for di bars. Yu go still kover all di bars with gold.
EXO 26:30 “Yu go build di tent as I show yu for di mountin.
EXO 26:31 “Make one curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon draw di angel wey get feada inside.
EXO 26:32 Den yu go hang am with gold hook for di four post wey dem make with akasia wood kon kover dem with gold.
EXO 26:33 Hang di curtain under di hook for di tent roof and for di curtain back. Yu go put di Kovenant Box for der. Di curtain go separate di Holy Place from di Holy of Holy.
EXO 26:34 “Put di kover on-top di Kovenant Box wey dey inside di Holy Place.
EXO 26:35 Make yu put di tabol for outside di Holy Place and di lampstand go dey opposite di tabol near di tent kon face sout, den yu go put di tabol for di nort side.
EXO 26:36 “For where dem go pass enter di tent, yu go make fine linen curtain wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with design.
EXO 26:37 And yu go still make hooks for dis curtain and five post with akacia wood kon kover dem with gold. Den do five bronze bottom for dem.
EXO 27:1 “Make yu make di altar with akasia wood. Yu go build am with four korna and as e wide rish seven fit six inches, na so too e go long rish. And e go high rish four fit six inches.
EXO 27:2 Den yu go make four horn for en four korna; di horns go bi part of am. Yu go take bronze kover am.
EXO 27:3 Yu go use bronze take make all di ash pots, shovels, tossin pot, meat hooks and fire pans.
EXO 27:4 Use bronze make filter and ring for en four korna.
EXO 27:5 Put di filter under di altar leg, so dat e go high rish half of di altar.
EXO 27:6 Den yu go make poles with akasia wood for di altar kon take bronze kover am.
EXO 27:7 Put di poles inside all di rings and di poles go dey di two altar side wen dem dey karry am.
EXO 27:8 Take wood make di altar kon put hole inside akordin to di plan wey I show yu for di mountin.
EXO 27:9 “Den yu go make kourtyard for di tent kon take fine linen curtains kover di sout-side and e go long rish one hundred and fifty fit for one side.
EXO 27:10 Make yu guide dem with twenty bronze post kon put dem on-top anoda twenty bronze stand, den hang di curtains with silva hook wey dem join with di silva rod wey join di post.
EXO 27:11 Na di same tin una go do for di nort side for di kourtyard; di curtains go bi one hundred and fifty fit wey dem support with twenty post wey stand on-top di bronze, with silva hook and di rods for all di post.
EXO 27:12 Di curtains for di west side go bi seventy-five fit wey dem support with ten post wey stand for ten place for groun.
EXO 27:13 Di side for di east where dem dey pass enter di kourtyard go wide rish seventy-five fit.
EXO 27:14 Di curtain for di rite side go long rish twenty-two and half fit and yu go support am with three post wey stand for three legs.
EXO 27:15 Di curtain for di left side go long rish twenty-two and half fit and yu go support am with three post wey dem stand for three place.
EXO 27:16 “For di kourtyard gate, make yu put curtain wey long rish thirty fit. Yu go make am with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with fine design and e go get four post with four bottom.
EXO 27:17 All di post wey dey inside di kourtyard go get silva rod and dem go use silva take make dia hook kon stand dem on-top di bronze.
EXO 27:18 Di kourtyard go long rish one hundred and fifty fit kon wide rish seventy-five fit and di top go high rish seven and half fit with dia bronze bottom.
EXO 27:19 “All di tins wey dem go use inside di tent and all di peg wey dem go take hold di tent and di kourtyard curtains, na bronze dem go take make dem.
EXO 27:20 “Make yu go kommand Israel pipol make dem give yu pure oil wey dem press komot from olive plant kon pour am for di lamp, so dat di lamps go always dey give lite.
EXO 27:21 Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”
EXO 28:1 “Yu go separate yor broda Aaron and en sons; Nadab, Abihu, Eleazar and Itama from Israel pipol so dat dem go serve mi as priest.
EXO 28:2 Make yu make special garment for yor broda Aaron, wey go gi-am beauti and honor.
EXO 28:3 Tell all di pipol wey know how to do dia handwork well-well and wey I don fill with di spirit wey dey give wisdom sey, make dem make Aaron garment wey go make am difren from oda pipol as e dey serve as my priest.
EXO 28:4 Na di kind garment wey dem go make bi dis: e go get chest kover, one priest garment, one robe, tunik wey get design, one priest kap and sash. Dem go still make special garment for Aaron sons wey dem go wear kon serve mi as priest.
EXO 28:5 Di workmen go use gold, blue, purpol and red wool, with fine linen.
EXO 28:6 “Dem go make di priest garment with gold, blue, purpol, red and fine linen wey dem weave and e must bi who know di work well-well.
EXO 28:7 E go get two pieces for front and back wey dem join for di shoulder.
EXO 28:8 Di waistband wey di artist weave go bi di same with di priest garment wey bi gold, blue, purpol and red wool, with fine linen wey dem weave.
EXO 28:9 Den yu go take two onyx stone kon use am rite Israel tribe names put for inside.
EXO 28:10 Six names go dey for one stone and di oda six go dey di sekond stone, just as dem take born dem.
EXO 28:11 Make yu use pesin wey know how to rite for stone take rite Israel shidren name for di two stones and make yu put dem on-top di gold.
EXO 28:12 Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.
EXO 28:13 Make yu set am with gold for two place,
EXO 28:14 den yu go tie am with two pure gold shain wey dem twist like rope.
EXO 28:15 “Make tailor wey sabi design klot, design di chest side wey dem go wear wen dem won go know God mind. Make yu make am like priest garment material: wey bi fine linen wey dem weave with gold, blue, purpol and red wool.
EXO 28:16 E go get four korna and wen dem fold am two times, e go long rish nine inches and na so e go still wide rish.
EXO 28:17 On-top am, yu go set four row put: di first row go bi one rubi stone, one topaz stone and one beryl stone.
EXO 28:18 Di sekond row go get one diamond stone, one safaya stone and one emerald stone.
EXO 28:19 Di third row go bi one jacint stone, one agate stone and one ametist stone.
EXO 28:20 Di fourt row go get one chrysolite stone, one onyx stone and one jasper stone. Yu go kover dem with gold for where dem go set dem put.
EXO 28:21 Yu go rite Israel twelf shidren names put for di stones and nor-tin go fit klean dem komot.
EXO 28:22 “Den make yu use pure gold take make shain wey bi like rope for di chest side.
EXO 28:23 Den yu go make two gold ring for di chest side kon join dem for di priest garment chest for up.
EXO 28:24 Yu go tie di two gold shain join di two rings for di end for di chest side,
EXO 28:25 den di oda two end for di two shain, yu go tie am join di two set kon still tie am join di shoulder pieces for di priest garment front.
EXO 28:26 Den make two ring with gold kon tie dem for di korna under di Breast Plate for inside, near di priest garment.
EXO 28:27 Yu go make more gold ring kon tie dem under di two shoulder pieces for di priest garment front, near where dem join am for top around di priest garment.
EXO 28:28 Make yu tie di Breast Plate rings join di priest garment rings with blue rope, so dat e go dey on-top di priest garment waistband.
EXO 28:29 So, Aaron go karry Israel sons name for di Breast Plate for en heart anytime e enter di Holy Place, just to always remind God about en pipol.
EXO 28:30 And yu go put di Urim and Tummim inside di Breast Plate, so dat anytime wen Aaron dey go meet God, e go wear am for en chest to know wetin dey God mind.
EXO 28:31 “Na blue yu go take paint evritin for di priest garment.
EXO 28:32 E go get hole for top and dem go weave di hole korna, so dat e nor go tear.
EXO 28:33 Yu go make pomegranate fruit from blue, purpol and red wool round di ending for di dress bottom and gold bells go dey round am.
EXO 28:34 Di way yu go make am go bi one gold bell, one pomegranate fruit and dem go dey round di dress for bottom.
EXO 28:35 Aaron go always wear dis dress wen e dey serve and pipol go hear bell sound wen ever e dey enter or komot from di Holy Place where God dey, (dis bell na to know if e dey alive or don die).
EXO 28:36 “Yu go take pure gold take make one plate and wetin yu go rite on-top na, ‘Na God holy pass.’
EXO 28:37 Make yu tie am put for blue lace, so dat e go dey di priest kap.
EXO 28:38 Aaron go always wear am for en fore head, so dat e go asept any sin wey Israel pipol kommit as dem dey offa dia gift give mi and den, I go forgive dem.
EXO 28:39 “Yu go weave di tunik with fine linen, den make di priest kap with fine linen and na who sabi design, go make am.
EXO 28:40 “Yu go make tunik and sashes for Aaron sons. Yu go make head-band for dem, so dat dem go get glory and beauti.
EXO 28:41 Yu go wear dem give Aaron yor broda and en sons. Yu go anoint, klean and santify dem, so dat dem go fit serve as my priests.
EXO 28:42 Make yu make linen for dem to take kover dia body: dem must kover demsef from dia neck go rish groun.
EXO 28:43 Aaron and en sons must wear am anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or wen dem dey go serve for di Most Holy Place for di altar, so dat dem nor go die, bikos of any sin. Dis kommandment na for Aaron and en shidren-shidren forever.”
EXO 29:1 “Dis na how yu go take dedikate Aaron and en sons as my priest. Yu go take one yong melu and two ram wey dey okay.
EXO 29:2 Den make bread wey nor get yist; kake wey dem mix with olive oil and biscuit wey dem rub with oil kon
EXO 29:3 put all of dem inside one basket with di melu and di two ram.
EXO 29:4 “Yu go bring Aaron and en sons near di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.
EXO 29:5 Di garment wey bi tunik, di priest garment dress, di main priest garment and di breast plate, yu go wear dem for Aaron. Yu go use waistband wey dem weave well-well, take tie di priest garment for en body.
EXO 29:6 Make yu put di priest kap for en head and di holy crown go dey on-top di priest kap.
EXO 29:7 Yu go pour and anoint am with di anointin oil.
EXO 29:8 Den yu go bring en sons kon wear di tunik for dem.
EXO 29:9 Put sash round dia waist kon wear head-band for dem, so dat dem go serve as priest, just as God kommand dem. Na so yu go take klean Aaron and en sons.
EXO 29:10 “Make yu bring di melu kom di tent front where dem for dey do meetin, den Aaron and en sons go put dia hand on-top di melu head.
EXO 29:11 Dem go kill di melu for where God dey for di tent door-mot where dem for dey do meetin.
EXO 29:12 Yu go take some of di melu blood with yor finger kon put am for di altar horn, den yu go pour di remainin blood under di altar.
EXO 29:13 Di fat wey dey inside di intestine; di part wey dey di liver top; di two kidney and dia fat, make yu take dem follow Aaron and en sons, den yu go burn dem for di altar.
EXO 29:14 But di melu flesh, en skin and en shit, yu go-go burn dem outside di kamp.
EXO 29:15 Yu go take one ram kon sey make Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
EXO 29:16 Den yu go kill di ram kon rub en blood round di altar.
EXO 29:17 Den yu go kut di ram into pieces, wosh di intestine and en two legs kon put dem on-top en head and di oda part.
EXO 29:18 Yu go burn all di ram for di altar. Na burnt ofrin to God and Oga God like di smell well-well; bikos na ofrin wey dem make with fire.
EXO 29:19 Yu go take di sekond ram, den Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
EXO 29:20 Den yu go kill-am, take some of en blood put for di korna for di sons rite ear, di first big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den sprinkol di blood round di altar.
EXO 29:21 Make yu take some blood wey dey di altar and some anointin oil, den sprinkol dem for Aaron and en sons body, so dat Aaron and en sons with dia garments, go dey holy.
EXO 29:22 “Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.
EXO 29:23 Make yu take one bread wey get olive oil; anoda one wey nor get and one biscuit from di bread basket wey dem give di Oga awa God.
EXO 29:24 Yu go put all dis tins for Aaron and en sons hand kon karry dem as special ofrin go give awa God.
EXO 29:25 Den yu go take di bread from dia hand kon burn dem for di altar as ofrin wey get betta smell to God.
EXO 29:26 Di ram wey yu use take klean Aaron, make yu take di breast kon karry am as betta ofrin to God and e go bi yor share.
EXO 29:27 “Make yu keep di part for di ram wey bilong to Aaron and en sons and na di breast and di lap wey dem karry give God as holy ofrin.
EXO 29:28 Anytin Israel pipol give God as dia peace ofrin, go bi Aaron and en sons share and nobody go shange dis law.
EXO 29:29 “Dem go take Aaron holy garment give en pikin afta en don die, so dat dem go anoint and make di pikin dey klean.
EXO 29:30 Anybody wey go take-ova from Aaron as priest among en sons, go wear di garment for seven days as e dey serve for di Tabanako and di Holy Place.
EXO 29:31 “Yu go take di ram kon kook en flesh for di Holy Place.
EXO 29:32 Aaron and en sons go chop di ram meat and di bread wey dey inside di basket for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin.
EXO 29:33 Na dem go still chop di bread and meat wey dem take klean and santify dem. No oda pesin go chop from dem, bikos di food dey holy.
EXO 29:34 And if any of di ofrin meat or di bread remain till morning, den yu go burn wetin remain with fire. Nobody must chop am, bikos e dey holy.
EXO 29:35 “Yu go anoint Aaron and en sons for seven days, just as I kommand yu.
EXO 29:36 Evriday, yu go prepare one melu as sin ofrin to klean dem. Yu go make sakrifice for di altar to klean am and yu go anoint and santify am.
EXO 29:37 For seven days, yu go make sakrifice for di altar kon santify am, den di altar go dey holy and anytin wey tosh di altar, go dey holy too.
EXO 29:38 “Naw, dis na wetin yu go prepare for di altar evriday: two lamb wey bi one year old.
EXO 29:39 Yu go prepare one among di lamb for morning and di sekond lamb, for evening.
EXO 29:40 Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.
EXO 29:41 Den di sekond lamb wey yu go offa for evening; yu go prepare am like di morning own, with drink ofrin wey get betta smell; ofrin wey dem make with fire for God.
EXO 29:42 “Dis one go bi burnt ofrin for God and dem go dey do am evritime for di Tabanako door-mot where dem for dey do meetin thru-out una generashon; bikos na dat place I go for meet and tok to yu.
EXO 29:43 I go meet Israel pipol for der too, bikos my present wey karry glory don make am holy.
EXO 29:44 I go santify di tent where dem for dey do meetin, di altar, Aaron and en sons, so dat dem go fit serve mi as priest.
EXO 29:45 I go stay with Israel pipol and I go bi dia God.
EXO 29:46 Den dem go know sey na mi bi dia God, wey take dem komot from Egypt, so dat I go fit stay with dem. Na mi bi di Oga wey bi dia God.”
EXO 30:1 “Yu go take akasia wood take make altar to burn incense.
EXO 30:2 E go long rish one fit and half and na so too e go wide rish; e go bi four korna. En horns go bi three fit for di four korna wey bi di same wood as di altar.
EXO 30:3 Yu go kover di top; all di four side and en horns wey bi pure gold, den kon take gold round am.
EXO 30:4 Yu go make two gold ring under di borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry am.
EXO 30:5 Yu go take akasia wood take make poles kon kover dem with gold.
EXO 30:6 Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu.
EXO 30:7 Evry morning wen Aaron kom prepare di lamp, e go burn sweet incense for di altar.
EXO 30:8 And evry evening wen e lite di lamp, e must still burn incense for God present. Dem go dey do dis tin from one generashon go rish anoda.
EXO 30:9 Make yu nor burn incense wey nor holy for di altar or any bad animal, korn or even pour drink ofrin on-top di altar.
EXO 30:10 Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
EXO 30:11 God kon tell Moses,
EXO 30:12 “Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem.
EXO 30:13 Anybody wey dem kount go give small silva as holy ofrin to Oga God. (Di amount na half shekel wey bi twenty gerah.)
EXO 30:14 Doz wey don rish twenty years, must give dis holy ofrin to God.
EXO 30:15 Wen una one give dis ofrin to God, so dat una go dey rite with am, rish pipol and poor pipol go pay di same tin.
EXO 30:16 Yu go kollect dis money from Israel pipol kon use dem take maintain di Tabanako. Bikos of dis, Israel pipol go always dey Oga God mind and E go klean una life.”
EXO 30:17 God tell Moses,
EXO 30:18 “Yu go still make bronze basin with bronze stand. Yu go put wota inside am kon put am between di tent wey dem for dey do meetin and di altar.
EXO 30:19 Aaron and en sons go use di wota take wosh dia hand and leg.
EXO 30:20 Wen ever Aaron and en sons dey enter di Tabanako go meet God or to go burn ofrins, dem must wosh demsef with wota, so dat dem nor go die!
EXO 30:21 Dem must always dey wosh dia hand and leg, so dat dem nor go die. Dis law na for dem and dia shidren forever.”
EXO 30:22 Den God tell Moses,
EXO 30:23 “Make yu selet betta spices like: twelf and half pounds of pure myrrh, sinamon wey get betta smell and make e bi six and one kwota pounds, sugarcane go bi six and one kwota pounds,
EXO 30:24 twelf and half pound of kassia and una go measure dem as dem dey measure di Tabanako shekel. Yu go still bring one gallon of olive oil.
EXO 30:25 Di anointin oil wey dem mix like perfume, go dey holy and dem go dey use am for God work.
EXO 30:26 Yu go use di oil take anoint di tent where dem for dey do meetin, di Testimony Box,
EXO 30:27 di tabol and all en material; di lampstand and wetin follow am, di incense altar,
EXO 30:28 di burnt ofrin altar and evry oda tin, di basin and en lampstand.
EXO 30:29 Den yu go santify dem and dem go dey holy. Anytin wey tosh dem go dey holy too.
EXO 30:30 Yu go anoint and santify Aaron and en sons, so dat dem go fit serve as my priest.
EXO 30:31 Make yu tell Israel pipol, ‘Una go always dey use dis holy anointin oil anytin una dey do God work.
EXO 30:32 Make una nor rub am for pipol body and make una nor make any oda oil wey bi like am. E dey holy and e must dey holy to una.
EXO 30:33 Anybody wey make perfume like am or take am rub strenja, dem go drive am komot from di kommunity.’ ”
EXO 30:34 God kon tell Moses, “Make yu take spices like: gum, resin, onyx, galbanum and pure frankincense and dem go bi di same amount.
EXO 30:35 Use dem take make incense wey dem mix with perfume. E must dey smooth, pure and holy.
EXO 30:36 Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu.
EXO 30:37 And yu must nor make dis kind perfume for yorsef, bikos dis one na for God and e must dey holy to yu.
EXO 30:38 Anybody wey make anytin like am, dem go drive am komot from di kommunity.”
EXO 31:1 God tell Moses,
EXO 31:2 “Si, I don koll Bezalel wey bi Uri pikin wey en grand-papa kom from Hur tribe for Judah.
EXO 31:3 I don put my Spirit inside am, so dat e go know how to do difren work.
EXO 31:4 E know how to design some fine tins with gold, silva and bronze and
EXO 31:5 how to kut wood and set stones. E still know how to do kraft work well-well.
EXO 31:6 I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do:
EXO 31:7 di Tabanako; di Testimony Box; di atonement box kover wey dey on-top; all di tins wey dey inside di Tabanako;
EXO 31:8 di tabol and di tins wey dey on-top; di pure lampstand with all di tins wey hold am, di incense altar,
EXO 31:9 di burnt ofrin altar with all di tins wey e dey use; di basin with en stand;
EXO 31:10 di garment wey dem weave; di holy garment wey Aaron and en sons go wear to take serve as priest;
EXO 31:11 di anointin oil and di sweet incense for di holy place. Di men must make evritin, just as I kommand yu.”
EXO 31:12 God kon tell Moses,
EXO 31:13 “Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una.
EXO 31:14 Una must keep di Sabat Day, bikos e dey holy to una. Anybody wey work for dat days, must die.
EXO 31:15 Una get six days to work, but di sevent day wey bi Sabat Day, na to rest, bikos e dey holy to God; anybody wey work for di sevent day, must die.
EXO 31:16 Israel pipol must keep di Sabat Day and obey am from one generashon go rish anoda. Dis kovenant go last forever.
EXO 31:17 Na sign between mi and Israel pipol forever. Bikos God use six days take kreate di heaven and di eart and E rest for di sevent day.’ ”
EXO 31:18 Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.
EXO 32:1 Wen di pipol si sey Moses nor dey kom down from di mountin, dem gada round Aaron kon tell am, “Make yu make one god for us wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt!”
EXO 32:2 So Aaron tell dem, “Make una bring di golds wey dey una wifes, sons and dotas ear kom.”
EXO 32:3 So, di pipol take dia gold go give Aaron.
EXO 32:4 Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
EXO 32:5 Aaron si as di pipol dey happy, so e build altar for di melu front kon sey, “Tumoro go bi Oga God Feast.”
EXO 32:6 Di pipol wake-up di next day to offa burnt and peace ofrin. Afta dis, dem celebrate kon dey chop and drink, den dem start to do wetin God sey make dem nor do.
EXO 32:7 God kon tell Moses, “Make yu kwik-kwik go down! Yor pipol wey yu take komot from Egypt don dey sin and rijet mi.
EXO 32:8 Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
EXO 32:9 Den God sey, “I don si how dis pipol sturbon and nor dey hear word.
EXO 32:10 Naw, make yu leave mi, so dat as I dey vex, I go distroy all of dem and I go make anoda great nashon from yu.”
EXO 32:11 But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?
EXO 32:12 Why Yu won let Egypt pipol sey, ‘Dia God save dem with di mind to kill all of dem for di mountin kon distroy dem komot from di eart?’ Make Yu shange yor mind about wetin Yu won do yor pipol, so dat Yu nor go dey vex for dem.
EXO 32:13 Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”
EXO 32:14 God shange en mind, so E nor kon ponish en pipol again.
EXO 32:15 Moses kom down from di mountin with di two kommandment stones for en hand. God rite for di two side for di stones.
EXO 32:16 Naw di stones dem na God word and na God rite wetin dey inside di two stones.
EXO 32:17 Wen Joshua hear di nois as di pipol dey shaut, e kon tell Moses sey, “Na war sound wi dey hear so for di kamp o-o.”
EXO 32:18 But Moses ansa, “Dat sound nor bi pipol wey dey shaut, bikos of viktory or kry bikos of defeat, but na music sound I dey hear.”
EXO 32:19 Wen Moses waka near di kamp kon si di melu and di way di pipol dey dance, e vex well-well. E trowey di stones wey dey en hand and dem kon break to pieces.
EXO 32:20 E take di melu wey dem make, burn am inside fire; grind am to powder kon pour am inside wota and e force Israel pipol make dem drink am.
EXO 32:21 Moses kon tell Aaron, “Wetin dis pipol do yu wey make yu kause dis great sin for dem?”
EXO 32:22 Aaron ansa, “My oga, make yu nor vex too mush for mi; yu know sey dis pipol wiked.
EXO 32:23 Dem tell mi sey, ‘Make yu make god wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt.’
EXO 32:24 So I tell dem, ‘Anybody wey get gold make e bring am kom.’ Wen dem give mi, I melt am and di gold kon turn to dis melu.”
EXO 32:25 Moses si sey bikos of Aaron, di pipol nor fit kontrol diasef again and dia enemies dey laf dem.
EXO 32:26 So Moses stand for di kamp gate kon shaut sey, “If yu dey God side, make yu kom meet mi.” Den Levi tribe gada go meet am.
EXO 32:27 Moses tell dem, “Di Oga wey bi Israel pipol God sey, ‘Make evribody karry dia swod, bigin kill each oda thru-out di kamp. Make una bigin kill unasef, brodas, friends and neighbours.’ ”
EXO 32:28 So Levi pipol kon do wetin Moses kommand and dat day, na about 3,000 pipol die.
EXO 32:29 Den Moses tell Levi pipol, “Today, una don prepare unasef as priest to serve God, bikos una obey am even doh una nid to kill una sons and brodas. So God don bless una.”
EXO 32:30 Di next day, Moses tell di pipol, “Una don kommit sirious sin; but naw, I go-go meet God, may bi E go fit forgive una.”
EXO 32:31 So Moses go meet God kon sey, “True-true, dis pipol don kommit sirious sin as dem make gold juju for demsef.
EXO 32:32 God, make Yu forgive dem, but if Yu nor go forgive dem, den make Yu remove my name from di book wey Yu rite.”
EXO 32:33 God ansa Moses, “No, doz wey sin against mi, na only dia names I go remove from my book wey get life.
EXO 32:34 Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”
EXO 32:35 So, God send diziz go meet di pipol, bikos dem woship di melu wey Aaron make.
EXO 33:1 God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’
EXO 33:2 And I go send one angel go before una rish der kon drive Kanaan, Amor, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot der.
EXO 33:3 Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”
EXO 33:4 Wen di pipol hear dis word, dem kon start to mourn and dem nor gri wear ear-ring or gold again.
EXO 33:5 God tell Moses, “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una too sturbon. So, if I go with una, I fit vex distroy una. Naw make una remove all una gold and fine klot, even doh I still dey tink wetin I go do with una.’ ”
EXO 33:6 So from di time wey Israel pipol komot from Mount Horeb, dem nor ever wear gold or ear-ring again.
EXO 33:7 Moses take di tent kon stand am for outside for di place wey far pass for di kamp and e koll am, “Di tent where dem go for dey meet.” Anybody wey won si God, go-go di tent for outside di kamp.
EXO 33:8 Wen Moses go di tent, all di pipol go get up kon stand for di gate for dia tent door and dem go dey look Moses until e enter di tent.
EXO 33:9 Anytime Moses enter di tent, di pila with kloud go kom down kon stand for di gate and God go tok to Moses.
EXO 33:10 Wen all di pipol si di pila with kloud for di gate, each pesin for en gate go stand up kon woship God.
EXO 33:11 God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.
EXO 33:12 Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’
EXO 33:13 Naw, if really sey I dey good for yor eye, make Yu show mi yor way; so dat I go know Yu more-more kon kontinue to dey good for yor eye. Den I go si sey dis pipol, na yor pipol.”
EXO 33:14 God ansa, “My present go-go with yu and I go give yu rest.”
EXO 33:15 Moses sey, “If Yu know sey yor present nor go-go with us, den make Yu nor take us komot from here.
EXO 33:16 How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”
EXO 33:17 God tell Moses, “I go still do wetin yu tok, bikos yu dey good for my eye and I know yu by yor name.”
EXO 33:18 Den Moses sey, “Make Yu show mi yor glory.”
EXO 33:19 God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.”
EXO 33:20 God still sey, “Yu nor go fit si my face, bikos nobody wey si my face go survive.”
EXO 33:21 God kon sey, “E get one place near mi where yu fit stand put on-top one rock.
EXO 33:22 And wen my glory dey pass, I go put yu for where open for di rock kon kover yu with my hand until I don pass.
EXO 33:23 Den I go take my hand komot and yu go si my back, but yu nor go si my face.”
EXO 34:1 God kon tell Moses, “Make yu kut two stones kom out like di first ones wey yu skata, den I go rite di same word put for dis ones.
EXO 34:2 Ready for morning den make yu klimb go Mount Sinai go wait for mi.
EXO 34:3 Make nobody follow yu klimb or near di mountin. Make any animal nor kom chop grass under di mountin.”
EXO 34:4 So for early morning, Moses kut two stones like di first ones kon klimb go Mount Sinai, just as Oga God kommand am and e karry di two stones follow body.
EXO 34:5 God kom down inside di kloud kon stand der with Moses, den E koll en own holy name wey bi Oga God.
EXO 34:6 God pass en front kon sey, “Na mi bi Oga God. I bi God wey get mesi and pity; I nor dey kwik vex; just as I big na so too my love big rish and I nor dey fail.
EXO 34:7 I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”
EXO 34:8 So Moses kwik-kwik bow woship am
EXO 34:9 kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”
EXO 34:10 God sey, “Si, I go make kovenant with Israel pipol. For dia present, I go do many wonders wey neva happen for anywhere for dis world or any kountry. And all di pipol wey dey with yu go si God work, bikos na wetin dey fear pesin, I dey do with una.
EXO 34:11 Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.
EXO 34:12 “Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol wey dey di land wey una dey go, if not, e go bi trap for una.
EXO 34:13 But una must distroy dia altars; skata dia images and kut dia Asherah juju poles trowey.
EXO 34:14 Una must nor woship any oda god, bikos di Oga God wey en name na Jealousy, na God wey dey really jealous.
EXO 34:15 “Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol for di land, bikos wen dem bigin woship and sakrifice to dia juju, dem go koll una make una join dem, den una go chop from dia sakrifice;
EXO 34:16 marry dia dotas for una sons and dia dotas go make una nor serve mi well, instead una go kon dey woship dia juju.
EXO 34:17 Make una nor mold or woship any gods.
EXO 34:18 “Una must always dey do di bread wey nor get yist feast. Una must chop bread wey nor get yist for seven days, just as I kommand and e go bi for Abib mont, bikos na for dat mont, una take komot from Egypt.
EXO 34:19 “Evry first-born wey bi man na my own; even di first pikin wey kattle, melu or sheep born.
EXO 34:20 Una fit use one lamb take buy donkey first pikin back, but if una nor go fit shange am, den make una break en neck. Una must buy all una first-born back. Nobody go kom meet mi with empty hand.
EXO 34:21 “Una go work for six days, but for di sevent day, una must rest; even if na wen una dey prepare una land to plant or harvest.
EXO 34:22 Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end.
EXO 34:23 Three times evry year, all una men must kom stand before di Oga wey bi Israel pipol God.
EXO 34:24 Bikos una dey kom meet mi di Oga una God three times evry year, I go drive di pipol for doz kountry wey won stop una and I go make una land big; so dat nobody go fit take una land.
EXO 34:25 “Make una nor offa my sakrifice blood with yist and di sakrifice from di Passova Feast, must nor remain rish di next day.
EXO 34:26 Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm kom di Oga una God house. Make una nor kill or chop animal wey still dey suck breast.”
EXO 34:27 God tell Moses, “Make yu rite dis words, bikos I don use dis word make kovenant with yu and Israel pipol.”
EXO 34:28 So Moses dey der with Oga God for forty days and forty nites; Moses nor chop bread or drink wota. E rite di kovenant word for di two stones and na dem bi di ten kommandment.
EXO 34:29 Wen Moses kom down from Mount Sinai with di two stones wey dem rite di kommand put, Moses nor know sey en face dey shine as e dey tok with God.
EXO 34:30 Wen Aaron and Israel pipol look Moses face, dem si sey e dey shine and dem kon dey fear to near am.
EXO 34:31 But Moses koll dem kom meet am, so Aaron and all di leaders waka go meet am. Den Moses tok to dem.
EXO 34:32 Afta dis, Israel pipol kon near am and e give dem all di kommandment wey God tell am for Mount Sinai.
EXO 34:33 Wen Moses don tok to dem finish, e kon go kover en face with klot.
EXO 34:34 But wen Moses dey go meet God, e dey remove di klot until e won kom meet di pipol. Den e go kom out kon tell Israel pipol wetin God kommand am.
EXO 34:35 Wen ever Israel pipol si Moses face dey shine, Moses go kover en face until e won go meet and tok to God.
EXO 35:1 Moses gada Israel pipol kon tell dem, “Dis na di word wey God sey una must do.
EXO 35:2 Una fit work for six days, but for di sevent day wey dey holy to una, na Sabat Day wen una go to take rest and woship God. Anybody wey work, go die.
EXO 35:3 Nobody must lite fire for en house for di Sabat Day.”
EXO 35:4 Moses kon tell Israel pipol, “Dis na di word wey God kommand.
EXO 35:5 Make una take ofrin kom give God. Make evribody give ofrin from en heart as e fit do; ofrin wey bi gold, silva, bronze,
EXO 35:6 blue, purpol and red wool, fine linen, goat hair,
EXO 35:7 ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood,
EXO 35:8 olive oil for di lantan, spices for di anointin oil and for di incense wey get good smell.
EXO 35:9 Onyx stones and oda difren stones to set for di priest garment and di Breast Plate.
EXO 35:10 “Anybody among una wey sabi work well-well, make e kom so dat dem go make all di tins wey God kommand:
EXO 35:11 di Tabanako with en tent, en kover, en klips, en frame, en cross bars, en post and wetin dem go stand put;
EXO 35:12 di box with en poles, di kover and di klot to take kover am,
EXO 35:13 di tabols with en poles and all en kontaina and di bread for en present;
EXO 35:14 di lite, di lampstand and di tins wey follow am; di lamp cup and oil for di lite;
EXO 35:15 di incense for di altar with en poles and di anointin oil; di incense wey get good smell and di curtain for di Tabanako gate;
EXO 35:16 di altar for di burnt ofrin with en bronze frame wey dey on-top and all wetin e dey use; di wosh-hand basin and en stand,
EXO 35:17 di curtain for di kourtyard, en post and en stand; di curtain for di kourtyard gate;
EXO 35:18 di Tabanako tent peg; di kourtyard tent peg and dia rope;
EXO 35:19 di garment wey dem weave to take serve for di Holy Place; di holy garments for Aaron and di garments for en sons to take serve as priest.”
EXO 35:20 Afta evritin, Israel pipol kon waka leave Moses.
EXO 35:21 And evribody wey en heart move am and en spirit like to give kon bring ofrin for God. Dem bring all di tins wey dem nid for di Tabanako, di tins wey dem go dey use do work for der and di tins for di holy garment.
EXO 35:22 Na both men and wimen kom, dat na di pipol wey dia heart like to give and dem bring dress pins, ear-rings, rings and ornament. Dem still bring difren tins wey dem make with gold as special ofrin to God.
EXO 35:23 And evribody wey get blue, purpol and red wool, fine linen, goat hair, ram skin wey dem dye to red and fine leda, bring dem kom.
EXO 35:24 All doz wey get silva or bronze give dem as ofrin to God and doz wey get akasia wood bring dem kom make dem take work.
EXO 35:25 All di wimen wey know how to weave and sew bring wetin dem don weave; both blue, purpol and red wool with fine linen.
EXO 35:26 And di wimen wey dia mind move dem kon weave all di goat hair to wool.
EXO 35:27 Di leaders bring onyx stones and oda ones to take set di priest garment and di Breast Plate front.
EXO 35:28 Dem still bring spices, olive oil for di lite, di anointin oil and di incense wey get good smell.
EXO 35:29 Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.
EXO 35:30 Den Moses tell Israel pipol, “God don koll Bezalel wey bi Uri pikin and Hur grand-pikin, wey kom from Judah tribe.
EXO 35:31 E don full Bezalel with en Spirit and E gi-am betta wisdom and undastandin, so dat e go fit do difren tins.
EXO 35:32 E sabi use gold, silva, bronze and e dey design too.
EXO 35:33 E sabi kut and set stones and dey use wood take do art work.
EXO 35:34 God give dis wisdom and undastandin to en and Oholiab wey en papa na Ahisamak from Dan tribe and dem go fit tish odas.
EXO 35:35 God give dem special skill to design with blue, purpol and red wool with fine linen and to weave dem too. Dem sabi dia work well-well.”
EXO 36:1 So God give wisdom and undastandin to Bezalel, Oholiab and all di pipol wey fit work, so dat dem go fit do anytin wey go help as dem dey build di Tabanako kon do evritin just as God kommand.
EXO 36:2 Den Moses tell Bezalel, Oholiab and evribody wey get handwork wey God don give wisdom and wey get mind to work sey, “Make una bigin work.”
EXO 36:3 Moses give dem di ofrins wey Israel pipol bring to take do di work for di Tabanako and di pipol still dey bring ofrin evry morning.
EXO 36:4 So all di pipol wey fit work wey dey di sanctuary leave dia work.
EXO 36:5 Dem go meet Moses kon sey, “Di tins wey di pipol don give don too many to komplete di work wey God kommand sey make wi do!”
EXO 36:6 Den Moses send message go evriwhere for di kamp sey, “Make nobody bring more ofrin for di Tabanako work again.” So di pipol kon stop to give.
EXO 36:7 All di tins wey di pipol bring pass wetin dem nid to take do di work.
EXO 36:8 All di pipol wey sabi work, make ten curtain for di Tabanako with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon design am with image wey bi like angel.
EXO 36:9 One curtain long rish forty-two fit kon wide rish six fit. All di curtains na di same size.
EXO 36:10 Dem join five curtains togeda to make one curtain and na so too dem join di oda six curtains togeda.
EXO 36:11 Den dem take blue material make shape for di korna for di curtain end for one set; dem still do di same tin along di korna for di curtain end for di sekond set.
EXO 36:12 Dem make fifty-fifty shape for di first curtain and for di curtain end wey dey di sekond set and di shapes dey opposite each oda.
EXO 36:13 Den dem make fifty gold hook take join di curtains togeda, so dat di Tabanako go bi one.
EXO 36:14 From di eleven curtain wey dem make from goat hair, dem use won take kover di Tabanako.
EXO 36:15 One curtain long rish forty-five fit and wide rish six fit; di eleven curtains, na di same size.
EXO 36:16 Bezalel join five togeda for one set and di remainin six for anoda set.
EXO 36:17 E still make fifty shape along di korna for di curtain end for one set and fifty for di curtain for di sekond set.
EXO 36:18 E still make fifty bronze hook to take join di tent togeda, so dat e go form one kover.
EXO 36:19 E make two kover; di first one na ram skin wey dem dye with red and di oda one na fine leda to take kover di first one.
EXO 36:20 E take akasia wood make di Tabanako frames wey stand.
EXO 36:21 Each frame long rish fifteen fit and e wide rish two and one kwota fit.
EXO 36:22 Each frame get two face wey mash each oda, so dat dem fit join di frames togeda. All di frames get di same face.
EXO 36:23 Dem make twenty frame for di sout-side
EXO 36:24 and forty silva base under each frame wey go hold di two face.
EXO 36:25 For di nort side for di Tabanako, e still make anoda twenty frame,
EXO 36:26 with dia forty silva bottom; two bottom under each frame.
EXO 36:27 For di west side for di Tabanako, e make six frame for am;
EXO 36:28 with two frames for di Tabanako korna for back.
EXO 36:29 For di two korna, e doubol am for di bottom kon join dem togeda for top with one ring. Na so e do for di two kornas.
EXO 36:30 Na eight frame e make and dia silva bottom na sixteen; two bottom for each frame.
EXO 36:31 Den e use akasia wood take make cross bar; five na for di frames for di nort side for di Tabanako
EXO 36:32 and five na for di frames for di sout-side for di Tabanako. E still make five bar for di frame wey dey di Tabanako back for west.
EXO 36:33 E make di middle bar from one end to di oda for where di oda frames dey.
EXO 36:34 Den e take gold wrap am kon make gold ring wey go hold di bar dem.
EXO 36:35 Den e use blue, purpol and red wool with fine linen wey dem weave take make di curtains kon design am with angel.
EXO 36:36 E take akasia wood make four post with four gold hook. E wrap dem with gold kon put dem on-top four silva bottom.
EXO 36:37 For di Tabanako gate, e use blue, purpol and red wool with fine linen wey dem weave, take make anoda curtain kon dekorate am.
EXO 36:38 E hook di curtains for five post. E dekorate di top and dia hook with gold; but na bronze e take make di five bottom.
EXO 37:1 Bezalel make di box with akasia wood; e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches and e high rish two fit three inches.
EXO 37:2 E wrap am with pure gold, both for inside and outside. Den e take gold make borda round am.
EXO 37:3 E make four gold rings kon tie dem for di four korna with two ring for one side and anoda two ring for di sekond side.
EXO 37:4 Den e use akasia wood take make poles kon wrap dem with gold.
EXO 37:5 E put di poles inside all di ring for di box korna, so dat dem go fit karry di box.
EXO 37:6 E still make di kover with pure gold and e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.
EXO 37:7 E melt gold take make two angel kon put dem for di two end for di kover.
EXO 37:8 One angel for one end and di oda angel for di oda end. E make dem, so dat dem go bi di same with di kover.
EXO 37:9 And di angels spread dia feada, so dat e go kover di box. Dem dey protet di box as dem face each oda.
EXO 37:10 Bezalel use akasia wood take make di tabol; e long rish three fit; wide like one fit six inches and e high rish two fit three inches.
EXO 37:11 E kover am with pure gold kon use gold do borda round am.
EXO 37:12 E still make frame for am wey wide rish three inches kon take am round am and e make gold borda for di frame.
EXO 37:13 Den e make four gold rings kon tie di rings for di four korna where di four legs dey.
EXO 37:14 Di rings dey near di frame to kreate shance for di poles wey karry di tabol.
EXO 37:15 Bezalel make dis poles with akasia wood kon dekorate dem with gold.
EXO 37:16 Den e use pure gold make special kontaina for di tabol tins like: plates, cups, jars and bowl wey dem go use take pour di wine ofrin.
EXO 37:17 Bezalel melt pure gold take make di lampstand. E make all di lampstand with en dekorashon with one material; di bottom, en shaft, en cups, di fine flower, en small-small seed and di petal.
EXO 37:18 Di lampstand get six branches wey kom out from all en side; tree branches from each side.
EXO 37:19 Each of di six branches get three cup wey dem design like flower wey get small-small seeds and dem dey shine.
EXO 37:20 Four cups wey get shape like almond flower wey get small-small seed, dey for di lampstand.
EXO 37:21 E get small-small seed under di first two branches wey kom out from am and na so e bi for di six branches with two branches afta each oda.
EXO 37:22 Dia small-small seed and branches na from di same material; all of dem na pure gold wey dem melt.
EXO 37:23 E still make seven lamp for di lampstand, with trimma and tray wey bi pure gold.
EXO 37:24 E make di lampstand and all di tins wey follow am with seventy-five pounds of pure gold.
EXO 37:25 Bezalel use akasia wood take make di incense altar. E long like one foot and half and na so e wide rish too, e kon bi skware. E high rish three fit. Na one material e still use make en horns.
EXO 37:26 E design am with pure gold both for di top, en four wall and en horns, den e use gold take make borda round am.
EXO 37:27 E still make two gold rings for am under en borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry dem.
EXO 37:28 E take akasia wood make di poles kon design dem with gold.
EXO 37:29 E make di holy anointin oil and di incense wey get good smell, just like pesin wey sabi make perfume, dey do.
EXO 38:1 E use akasia wood take make di burnt ofrin altar. E long rish seven and half fit; wide rish seven and half fit skware and e high rish four and half fit.
EXO 38:2 E make horn for en four kornas; di horns na part of am. And e kover dem with bronze.
EXO 38:3 Den e make all wetin dem go use for di altar. Tins like pot, shovel, tossin pot, meat hook and fire pan and na bronze e take make all of dem.
EXO 38:4 E make bronze frame for di altar and for under am.
EXO 38:5 E make four rings for di bronze frame for di four korna, so dat space go dey for di poles.
EXO 38:6 E take akasia wood make poles kon kover dem with bronze.
EXO 38:7 Den e put di poles inside di rings for di altar. E make di altar with board and e get holes.
EXO 38:8 E make di bronze basin and en bronze stand from di mirror wey bilong to di wimen wey dey serve for di Tabanako gate.
EXO 38:9 E make di kourtyard for di sout-side kon hang en curtain with fine linen wey long rish one hundred and fifty fit,
EXO 38:10 with dia twenty post, dia twenty bronze stand, silva hooks and rods.
EXO 38:11 For di nort side, di curtain na one hundred and fifty fit, with dia twenty post, dia twenty bronze stand, silva hooks and rods.
EXO 38:12 For di west side, di curtain long rish seventy-five fit, with dia ten posts; di ten stand; dia silva hooks and rods.
EXO 38:13 Den for di east side where di sun from dey raiz, di curtain wide rish seventy-five fit too.
EXO 38:14 Di curtains for one side long rish twenty-two and half fit, with dia three post and three stand.
EXO 38:15 For di sekond side for di kourtyard gate, just like di oda one, di curtain long rish twenty-two and half fit, with di three post and three stand to support am.
EXO 38:16 Na fine linen dem take make all di curtains wey round di kourtyard.
EXO 38:17 Di stands for di posts na bronze. Di hooks for all di post and dia band, na silva and dem kover dem with silva for dia top. All di kourtyard posts get silva bands.
EXO 38:18 Di curtain for di kourtyard gate na blue, purpol and red wool with fine linen and dem design dem well-well. E long rish three fit and like di curtain for di kourtyard, na so too e high rish seven and half fit
EXO 38:19 with four post and four bronze stands. Dia hook and rods na silva and dem kover dem with silva for top.
EXO 38:20 All di tent pins for di Tabanako and round di kourtyard, na bronze dem take make dem.
EXO 38:21 Dis na di materials wey dem use take build di Tabanako, just as Moses tok. Na Levi pipol do di work and Itama wey bi Aaron pikin, na-im dey show dem wetin dem go do.
EXO 38:22 Naw, Uri pikin Bezalel wey Hur wey kom from Judah bi en grand-papa, make evritin just as God kommand Moses;
EXO 38:23 and Oholiab wey bi Ahisamak pikin wey kom from Dan tribe, dey with am and e dey karve; design and weave blue, purpol and red wool with fine linen.
EXO 38:24 All di gold wey dem use for di Tabanako work, na ofrin wey rish twenty-nine talent and seven hundred and three shekel akordin to di Tabanako shekel.
EXO 38:25 And di silva from di pipol wey dem kount for di kommunity na one hundred talent and 1,775 shekel as dem go kount am for di Tabanako.
EXO 38:26 Dis amount na di same for each pesin. Na di same as half shekel akordin to di Tabanako shekel, bikos di pipol wey plenty rish like dat from twenty years go up, na 603,550 dem bi.
EXO 38:27 Na one hundred talent of silva dem use take make di stand for di Tabanako and di curtain; one hundred stand na for one hundred talent; while one talent na for each stand.
EXO 38:28 From di 1,775 shekel wey remain, Bezalel make hooks for di posts kon kover dia top, den e make rod for dem.
EXO 38:29 Di bronze from di ofrin na seventy talent and 2,400 shekel.
EXO 38:30 With dem, Bezalel make di stand for di tent door where dem for dey do meetin and di bronze altar; di bronze frame for am and all di tins wey dem go use for di altar,
EXO 38:31 round di stands for di kourtyard and di stands for di gate; all di tent pins with di ones wey dey round di kourtyard.
EXO 39:1 From di blue, purpol and red wool, dem kon make garments wey dem weave to take serve for di sanctuary; dem make holy garments for Aaron just as God kommand Moses.
EXO 39:2 E use gold, blue, purpol and red wool with fine linen take make priest garment.
EXO 39:3 Dem melt di gold kon turn am to flat shit, den kut am small-small, so dat dem go weave dem to di blue, purpol and red wool with fine linen and dis na di artist work.
EXO 39:4 Dem make shoulder part for am kon tie am join di two kornas, so dat dem go join dem togeda.
EXO 39:5 Di fine belt wey dem weave join di priest garment na di same material with am, so dat e go bi one piece with di gold, blue, purpol and red wool with fine linen, just as God kommand Moses.
EXO 39:6 E put di two onyx stones inside gold wey dem design, den rite Israel sons name put.
EXO 39:7 E put dem for di priest garment shoulder pieces as stones to take remember Israel sons, just as God kommand Moses.
EXO 39:8 Den e make di Breast Plate kon design am like di priest garment with gold, blue, purpol and red wool with fine linen.
EXO 39:9 Na skware e bi, e doubol di Breast Plate and e long rish nine inches kon still wide like dat wen dem doubol am.
EXO 39:10 Dem put four row of stones on-top am: di first row na with rubi stone, topaz stone and beryl stone.
EXO 39:11 Di sekond row na turkwoise stone, safaya stone and emerald stone;
EXO 39:12 di third row na with jacint stone, agate stone, ametist stone
EXO 39:13 and di fourt row na with chrysolite stone, onyx stone and jasper stone. Dem put dem inside di gold wey dem dekorate.
EXO 39:14 Di stones na Israel twelf sons name and each name na akordin to di twelf tribes and dem make am as dem take seal am.
EXO 39:15 Dem take pure gold make shain wey twist like rope.
EXO 39:16 Dem make two gold dekorashon and two gold ring kon tie di two rings join di end side for di Breast Plate.
EXO 39:17 Dem tie di two gold shain to di two rings for di Breast Plate ending
EXO 39:18 kon tie di oda two end side for di two shain to di two setin, den tie dem for di priest garment shoulder pieces front.
EXO 39:19 Den dem use gold take make two rings put for di oda two end for inside di priest garment for di Breast Plate.
EXO 39:20 Dem still make two gold rings kon tie dem join di bottom for di two shoulder pieces for di priest garment front, near where dem join am for di priest garment belt.
EXO 39:21 Dem tie di Breast Plate for di rings to di priest garment rings with blue rope, so dat e go dey for di priest garment belt top and di Breast Plate nor go luz komot from di priest garment, just as God kommand Moses.
EXO 39:22 E weave di priest garment robe with blue.
EXO 39:23 Di robe centre open like kollar wey dem weave di korna round, so dat e nor go tear.
EXO 39:24 Dem make pomegranate fruit with blue, purpol and red wool with fine linen round di robe.
EXO 39:25 Dem use pure gold take make bell kon tie di bell between di pomegranate fruit round di robe.
EXO 39:26 E get one bell and one pomegranate fruit round di robe, wey dem go take dey minister, just as God kommand Moses.
EXO 39:27 Dem weave fine linen for Aaron and en sons
EXO 39:28 and fine linen priest kap, linen head-band and fine linen undawear.
EXO 39:29 Di sash na fine linen and blue, purpol and red wool wey dem do with design, just as God kommand Moses.
EXO 39:30 Dem make one plate, di holy crown with pure gold and dem rite on-top am just as dem dey rite for seal sey, “Holiness na God own.”
EXO 39:31 Den dem tie one blue rope join am with di priest kap for top, just as God kommand Moses.
EXO 39:32 So dem kon finish di Tabanako work and di tent where dem for dey do meetin. Israel pipol do just as God kommand Moses.
EXO 39:33 Dem show Moses di Tabanako, di tent and all di tins for inside. Di whole frame, bar, post and stands.
EXO 39:34 And di ram skin wey dem dye red as kover; di fine leda kover and di curtain to guide am.
EXO 39:35 Di Kovenant Box, en poles and di kover;
EXO 39:36 di tabol; all en tools and di bread for en present;
EXO 39:37 di pure lampstand; en lamps, di lamp wey e set well and all wetin follow am; di oil for di lite;
EXO 39:38 di gold altar; di anointin oil and di incense wey get good smell. Di curtain for di tent gate;
EXO 39:39 di bronze altar and en frame; en poles and all wetin follow am; di basin with en stand;
EXO 39:40 di kourtyard curtains; en posts, stand and di curtain for di kourtyard gate. En ropes; di tent pins and all di tins wey dem go use for di Tabanako work and for di tent where dem for dey do meetin.
EXO 39:41 Di garment wey dem weave to take serve for di Tabanako, di holy garments for Aaron; di post and di garment wey en sons go wear take serve as priest.
EXO 39:42 Israel pipol do all di work, just as God kommand Moses.
EXO 39:43 Moses si di work kon know sey dem do am, just as God kommand, so e kon bless dem.
EXO 40:1 Den God tell Moses:
EXO 40:2 “For di first day for di first mont, yu go arrange di Tabanako, di tent where dem for dey do meetin.
EXO 40:3 Yu go put di Testimony Box inside kon kover di box with curtain.
EXO 40:4 Yu go bring di tabol inside kon put di tins wey bilong to am on-top; den yu go bring di lampstand inside with en lamps.
EXO 40:5 “Yu go put gold altar for di incense for di Testimony Box front kon put di curtain for di Tabanako gate.
EXO 40:6 Yu go put di altar for di burnt ofrin for di Tabanako gate and di tent where dem for dey do meetin.
EXO 40:7 And yu go put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar, den pour wota inside.
EXO 40:8 Yu go put di kourtyard round am kon put di curtain for di kourtyard gate.
EXO 40:9 “Make yu take di anointin oil, anoint di Tabanako and all di tins wey dey inside kon santify dem with all en tins and dem go dey holy.
EXO 40:10 Den yu go anoint di altar for di burnt ofrin with all en tins kon santify di altar and e go bi di altar wey dey holy pass.
EXO 40:11 Yu must anoint and santify di basin and en stand.
EXO 40:12 “Yu go bring Aaron and en sons kom di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.
EXO 40:13 Den yu go dress Aaron with di holy garments kon anoint and santify am make e for fit serve as my priest.
EXO 40:14 Yu go bring en sons, dress dem with tunik
EXO 40:15 kon anoint dem, just as yu anoint dia papa make dem for fit serve as my priests too and dia anointin go make dem kontinue di work thru-out dia generashon.”
EXO 40:16 Dis na wetin Moses do akordin to evritin wey God kommand am.
EXO 40:17 So dem start to use di Tabanako for di first day for di first mont for di sekond year.
EXO 40:18 Wen Moses start to use di Tabanako kon put di stands for dia place, e arrange di frames kon tie di bars. E still arrange di posts.
EXO 40:19 Den e spread di tent on-top di Tabanako kon kover am, just as God kommand am.
EXO 40:20 E take di testimony stones kon put am inside di box, tie di poles for di box, den put di kover on-top.
EXO 40:21 E take di box enter di Tabanako; hang di curtain wey dey protet am kon kover di Testimony Box, just as God kommand.
EXO 40:22 E put di tabol inside di tent where dem for dey do meetin for di nort side, outside di curtain.
EXO 40:23 Den e set di bread on-top am for God front, just as God kommand.
EXO 40:24 E put di lampstand inside di tent where dem for dey do meetin opposite di tabol for di sout-side.
EXO 40:25 And e put di lamps before God, just as God kommand am.
EXO 40:26 E put di gold altar inside di tent where dem for dey do meetin for di curtain front
EXO 40:27 den di incense wey get good smell, e kon burn am put, just as God kommand.
EXO 40:28 Den e put di curtain for di Tabanako door.
EXO 40:29 E still put burnt ofrin altar for di Tabanako gate, di tent where dem for dey do meetin kon put di burnt ofrin and food ofrin for top, just as God kommand.
EXO 40:30 Den e put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar kon pour wota inside to take dey wosh.
EXO 40:31 Moses, Aaron and en sons go wosh dia hand and leg for inside.
EXO 40:32 Anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or waka near di altar, dem go first wosh dia body, just as God kommand.
EXO 40:33 E set di kourtyard round di Tabanako and di altar, den put di curtain for di gate for di kourtyard. So Moses finish di work.
EXO 40:34 Den di kloud kover di tent where dem for dey do meetin and God glory kon full inside di Tabanako.
EXO 40:35 Moses nor fit enter di tent where dem for dey do meetin, bikos di kloud rest on-top am and God glory kover di Tabanako.
EXO 40:36 But wen ever di kloud komot from di Tabanako, Israel pipol go kontinue dia journey;
EXO 40:37 but if di kloud nor komot, dem nor go-go anywhere until di day wen di kloud go komot.
EXO 40:38 God kloud dey-dey di Tabanako for day time and na fire e dey bi for nite and evribody for Israel dey si am as dem dey travel.
LEV 1:1 God koll Moses kon tell am from di Tabanako sey:
LEV 1:2 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen anybody one sakrifice animal give God, e fit use en kattle, sheep or goat.
LEV 1:3 “ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.
LEV 1:4 E go put en hand for di animal head and God go asept am as sakrifice to take forgive en sin.’
LEV 1:5 Den e go kill di animal for der and di priests wey bi Aaron sons go give God di blood kon put am for di four side for di altar wey dey for di tent gate.
LEV 1:6 Den di pesin wey dey give di ofrin go remove di animal skin kon kut am small-small
LEV 1:7 and di priests go arrange and lite firewood near di altar.
LEV 1:8 Dem go put all di animal part for inside, plus di head and di fat.
LEV 1:9 Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs and di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 1:10 “ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay.
LEV 1:11 E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar.
LEV 1:12 Afta di man don kut am small-small, di priest go kon put all di animal part, plus en head and fat for fire.
LEV 1:13 Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 1:14 “ ‘If di man one give bird as burnt ofrin, e must bi dove or pijin.
LEV 1:15 Di priest must offa am for di altar, e go twist en neck kon burn en head for di altar. E go remove di blood kon put am for di altar side.
LEV 1:16 E go remove di intestine and all di tins wey dey inside kon trowey dem for di east side for di altar where dem dey put di ashes.
LEV 1:17 E go hold di feada kon tear di body open. E nor go allow di feada fall komot, den e go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 2:1 “ ‘Wen una dey give korn ofrin to God, una must first grind am to powder. Una must put olive oil and incense on-top
LEV 2:2 kon take am go give Aaron sons wey bi priest. Di priest go pak di flower, oil and all di incense full en hand kon burn am for di altar as part of di ofrin wey dem give God. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 2:3 Di remainin korn ofrin na di priests own; e dey holy, since dem remove am from di food wey dem give God.
LEV 2:4 “ ‘If di ofrin na bread wey dem bake for oven, den dem must nor make am with yist. E fit bi tick bread or biscuit wey dem make with flower kon mix am with olive oil.
LEV 2:5 If di ofrin na bread wey dem kook for iron plate, dem go make am with flower wey dem mix with olive oil, but make e nor get yist.
LEV 2:6 Make dem grind am to pieces kon pour olive oil inside, bikos na korn ofrin.
LEV 2:7 If di ofrin na bread wey dem kook for plate, dem must make am with flower and olive oil.
LEV 2:8 “ ‘Make una bring am to di priest as ofrin for God and di priest go take am go di altar.
LEV 2:9 Di priest go take some for inside kon burn am for di altar. God like dis food ofrin smell well-well, bikos e dey special.
LEV 2:10 Di remainin ofrin na di priest own; e dey holy, bikos dem take am komot from di food ofrin wey dem give God.
LEV 2:11 “ ‘Make una nor give God korn ofrin wey dem make with yist; una must nor make di food ofrin wey una go give God with yist or honey.
LEV 2:12 Una go give God ofrin from di first korn wey una harvest each year, but una nor go burn am for di altar.
LEV 2:13 Make una put salt for all una korn ofrin, bikos di salt dey show di kovenant between una and God.
LEV 2:14 “ ‘Wen una dey bring di ofrin wey una get from di first korn wey una harvest, make una give korn wey dem roast and food wey dem grind.
LEV 2:15 Make una put olive oil and incense on-top.
LEV 2:16 Di priest go burn di part for di food and di oil wey e take, plus all di incense and dem go bi food ofrin to God.
LEV 3:1 “ ‘Wen pesin won give en animal as peace ofrin, e fit bi man or woman own, but di animal must dey okay.
LEV 3:2 Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side
LEV 3:3 kon give all dis parts for di animal to God as food ofrin: all di fat wey dey inside di animal intestine;
LEV 3:4 di kidney, di fat wey dey di kidney and di part for di liver wey good well-well.
LEV 3:5 Di priest go burn all of dem for di altar with di burnt ofrin. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 3:6 “ ‘Dem fit use sheep or goat take do peace ofrin, weda na man or woman, but e must dey okay.
LEV 3:7 If una give sheep as ofrin, una must gi-am for God present.
LEV 3:8 Una go put una hand for di animal head kon kill-am for where dem for dey do meetin for di tent door-mot. Di priest go rub di blood for di altar four side
LEV 3:9 kon give all dis part to God as food ofrin: di fat, all di fat tail wey dem kut komot from near di backbone; all di fat wey kover di animal intestine;
LEV 3:10 di kidney and di fat wey dey di kidney; plus di part for di liver wey good well-well.
LEV 3:11 Di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God.
LEV 3:12 “ ‘If una give goat as una ofrin, una must bring am kom God present,
LEV 3:13 put una hand for di animal head kon kill-am for di tent front. Di priest go rub di blood for di altar four side
LEV 3:14 kon give all dis part to God as food ofrin: all di fat wey dey di intestine,
LEV 3:15 di two kidney with dia fat and di part for di liver wey good well-well.
LEV 3:16 Den di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God and God like am well-well. All di fat na God own.
LEV 3:17 “ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”
LEV 4:1 God kommand Moses,
LEV 4:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na how una go trit anybody wey break God kommand by mistake.
LEV 4:3 “ ‘If na di High Priest sin kon make di pipol dey guilty, e go give one yong melu wey dey okay to God for en sin.
LEV 4:4 E go take di melu go di tent gate, put en hand for di melu head kon kill-am for God present.
LEV 4:5 Den di High Priest go take some of di melu blood kon karry am enter di tent.
LEV 4:6 E go shuk en finger for di blood kon sprinkol am seven times for di holy curtain front.
LEV 4:7 Den e go put some of di blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain under di altar wey dem dey use take dey burn ofrin, wey dey di tent gate.
LEV 4:8 E go take all di fat from di sin ofrin melu, plus di fat wey dey di intestine;
LEV 4:9 di two kidney and dia fat and di part for di liver wey good well-well.
LEV 4:10 Di priest go take dis fat kon burn am for di altar wey dem dey use for burnt ofrin, just as e dey do for any animal wey dem kill for di peace ofrin.
LEV 4:11 But e go take di skin, all di flesh, leg and intestine
LEV 4:12 den karry dem go outside di kamp for where dem dey pour ash put, den e go burn dem for der with firewood.
LEV 4:13 “ ‘If na Israel pipol kommit sin by mistake kon break one of God kommand and dem nor know, dem still don sin bi dat.
LEV 4:14 But wen dem know sey dem sin, di pipol must bring one yong melu take do sin ofrin. Dem go bring am kom di tent where dem for dey do meetin.
LEV 4:15 Di leaders go put dia hand for di melu head kon kill-am for der for God present.
LEV 4:16 Di High Priest go take some of di melu blood go inside di tent.
LEV 4:17 E go shuk en finger for di blood kon sprinkol am seven times for di holy curtain front.
LEV 4:18 Den e go put some blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain for under di altar wey dem dey use take dey burnt sakrifice wey dey di tent gate.
LEV 4:19 Den e go take all di fat kon burn dem for di altar.
LEV 4:20 E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.
LEV 4:21 E go karry di melu go outside di kamp go burn am, just as e take burn di melu wey e give for en own sin.
LEV 4:22 “ ‘If one among Israel leaders sin kon break God kommand by mistake,
LEV 4:23 den as e just know sey e sin, e must bring woman goat wey dey okay as en ofrin.
LEV 4:24 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. Dis na di ofrin wey dey remove sin from pesin body.
LEV 4:25 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
LEV 4:26 E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.
LEV 4:27 “ ‘If na ordinary pesin sin kon break God kommand by mistake,
LEV 4:28 den as e just know sey e sin, e go bring woman goat wey dey okay as en ofrin.
LEV 4:29 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin.
LEV 4:30 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
LEV 4:31 E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
LEV 4:32 “ ‘If e bring sheep as en sin ofrin, e must bi woman own wey dey okay.
LEV 4:33 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin.
LEV 4:34 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
LEV 4:35 E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
LEV 5:1 “ ‘If dem koll yu make yu kon tok about sometin wey yu si or wey happen for yor present and yu nor gri, yu don sin bi dat and dem must ponish yu.
LEV 5:2 “ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.
LEV 5:3 “ ‘Or if yu by mistake tosh sometin wey dey make pesin dirty for God eye, den wen yu know, yu must gri sey yu don sin.
LEV 5:4 May bi pesin make vow wey e nor sirious about, no matter wetin e bi, e don kommit sin wons e know wetin e do.
LEV 5:5 “ ‘If anybody know sey e dey guilty for wetin e do, dat pesin fit go konfess en sin.
LEV 5:6 Den e must bring woman goat or sheep kon give God as ofrin for en sin. Dis na sin ofrin wey di priest go take klean am, so dat God go forgi-am.
LEV 5:7 “ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.
LEV 5:8 E go bring dem kom meet di priest, wey go first offa di bird for di sin ofrin kon break en neck, but e nor go komot di neck from di body.
LEV 5:9 Den e go sprinkol some of di sin ofrin blood for di altar kon pour di remainin one under di altar. Dis na for di sin ofrin.
LEV 5:10 Den e go offa di sekond bird as burnt ofrin akordin to di law. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
LEV 5:11 “ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin.
LEV 5:12 E go bring am kom meet di priest wey go pak di flower full en hand as di sin ofrin to God, den e go burn am for di altar as food ofrin, even doh na sin ofrin e bi.
LEV 5:13 As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. Di remainin flower na di priest own, just as e bi for korn ofrin.’ ”
LEV 5:14 Den God tell Moses:
LEV 5:15 “Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel.
LEV 5:16 Any holy tin wey e spoil, e must pay back and e go add twenty percent give di priest and di priest go offa di animal as sakrifice for di sin wey di man kommit, den God go forgi-am.
LEV 5:17 “If anybody break God kommand and e nor know, di pesin dey guilty and e must pay for en sin.
LEV 5:18 E go bring man sheep or goat wey dey okay kon give di priest as ofrin for en sin. Den e go measure am akordin to di Tabanako shekel. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
LEV 5:19 Dis ofrin na for di sin wey pesin sin against God.”
LEV 6:1 Den God tell Moses:
LEV 6:2 “If pesin sin against God wen e nor gri riton wetin e take as shorti from anoda pesin or wen e tif or play wayo,
LEV 6:3 or e si sometin wey lost kon lie and swear sey e nor si am, e must give ofrin.
LEV 6:4 If any man kommit dis kind sin, evritin wey e get thru wayo or lie-lie, e go must riton dem.
LEV 6:5 Di day wey e dey riton dem, e go pay di owner komplete money kon add twenty percent join am.
LEV 6:6 Den e go take en sin ofrin go give God thru di priest and e go bring ram wey dey okay and wey dem go fit shange to silva shekel for en sin ofrin.
LEV 6:7 As di priest offa dis sakrifice, di man go dey good for God eye again and God go forgi-am.”
LEV 6:8 God tell Moses:
LEV 6:9 “Make yu kommand Aaron and en sons sey, ‘Dis na di burnt ofrin law. Dem go leave di burnt ofrin on-top di altar till day break and di fire go kontinue to dey burn.
LEV 6:10 Den di priest go wear e linen robe and nika, remove di ashes for di fire wey dey di altar kon put dem near di altar.
LEV 6:11 Den e go shange en klot kon take di ashes go one klean place for outside di kamp.
LEV 6:12 But di fire wey dey di altar must kontinue to dey burn. Make dem nor kwensh am. Evry morning, di priest go put firewood on-top di fire, e go arrange di burnt ofrin on-top am kon burn di fat for di peace ofrin.
LEV 6:13 Di fire must kontinue to dey burn on-top di altar and dem nor go let am kwensh.
LEV 6:14 “ ‘Dis na di law for korn ofrin. Aaron sons go present am before God for di altar front
LEV 6:15 and di priest go pak some of di flower, di oil and di incense for di top kon burn am on-top di altar as sakrifice to God. God dey like dis ofrin smell.
LEV 6:16 Aaron and en sons go chop di remainin ones. Dem go take am make bread wey nor get yist kon chop am for di Holy Place where God Temple dey.
LEV 6:17 Dem must nor make di bread with yist. I don gi-am to dem as gift. E dey holy well-well like di one for sin and guilt ofrin.
LEV 6:18 Evry boy pikin wey Aaron born, must chop am. Na dis go always bi dia share wen ever dem offa ofrin to God. God go ponish anybody wey tosh di food ofrin, bikos e dey holy.’ ”
LEV 6:19 Den God tell Moses:
LEV 6:20 “Dis na di ofrin wey Aaron and en sons go present to God for di day wey dem go anoint dem: One kilogram of flower (di same amount as evriday korn ofrin), half for morning and half for evening.
LEV 6:21 Dem go mix am with oil kon kook am with iron plate. Dem go soak am well-well, before dem go bring am kom. So una go present am as korn ofrin, di kind smell wey God dey like well-well.
LEV 6:22 Di priest wey go take-ova from Aaron among en sons, go always dey do am. Na God get am and dem go burn am komplete. Dis law na forever.
LEV 6:23 Dem nor go chop any part for di korn ofrin wey di priest make; dem must burn all of dem finish.”
LEV 6:24 Den God tell Moses:
LEV 6:25 “Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God.
LEV 6:26 Di priest wey sakrifice di animal go chop am for di Holy Place inside God Temple where dem for dey meet.
LEV 6:27 Anybody wey tosh di animal meat must dey holy and anybody wey di animal blood stain en garment or di Holy Place, must wosh am.
LEV 6:28 Dem must break di klay pot wey dem take boil di meat, but if dem use iron pot, dem go wosh am well-well kon rinse am with wota.
LEV 6:29 Di men among di priest family fit chop dis ofrin, bikos e dey holy.
LEV 6:30 But if dem karry di blood enter God Temple kon use am as sakrifice to remove sin, dem nor go chop di animal at-all; dem must burn am finish.’ ”
LEV 7:1 God still tell Moses, “Dis na di law for guilt ofrin and e dey holy.
LEV 7:2 Una go do di guilt ofrin for di nort side for di altar, where dem for dey do di burnt ofrin kon rub di blood for di four side for di altar.
LEV 7:3 Una go remove all di fat wey dey di animal kon offa am to God for di altar: di fat tail, di fat wey kover di intestine,
LEV 7:4 di two kidney and dia fat and di best part for di liver.
LEV 7:5 Di priest go burn all di fat for di altar as food ofrin to God. Na dis bi di guilt ofrin.
LEV 7:6 Anybody wey kom from di priest family fit chop am. Dem must chop am for di Holy Place, bikos e dey holy.
LEV 7:7 Dis law na di same for both sin and guilt ofrin: na di priest wey sakrifice am get di meat.
LEV 7:8 “Di animal skin wey dem give as burnt ofrin na di priest wey sakrifice am, get am.
LEV 7:9 Evry korn ofrin wey dem bake for oven, pan or iron plate, na di priest wey offa am to God, get am.
LEV 7:10 But korn ofrin wey dem nor kook, weda dem mix am with oil or dry am, na Aaron sons get am and dem must share am among dem.
LEV 7:11 “Dis na di law for di peace ofrin wey dem sakrifice give God.
LEV 7:12 If anybody tank God with dis ofrin, e go still bring bread wey dem nor make with yist: weda di bread strong or dem mix am with olive oil. E fit bi biscuit wey dem rub olive oil put or kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil.
LEV 7:13 E go still give bread wey dem bake with yist for dis ofrin too.
LEV 7:14 E go give one part for each bread as special ofrin to God; na di priest wey take and rub di animal blood for di altar, get am.
LEV 7:15 Dem must chop di meat for di same day wey dem sakrifice am; no meat must remain till di next morning.
LEV 7:16 “If anybody bring peace ofrin to take pay en vow or e do am from en mind, nor bi all of dem una go chop di day wey e gi-am, but dem fit chop di remain wons for di next day.
LEV 7:17 But dem must burn di meat wey remain for di third day.
LEV 7:18 If dem chop any one for di third day, God nor go asept di man ofrin. God nor go favor en and di ofrin, bikos e nor dey klean and anybody wey chop am go sofa di ponishment.
LEV 7:19 “If di meat tosh wetin nor dey klean, den una must nor chop am; una must burn am for fire. But meat wey dey klean, evribody wey dey klean fit chop am,
LEV 7:20 but if pesin wey nor dey klean go chop am, e nor go dey among God pipol again.
LEV 7:21 If anybody tosh wetin nor dey klean, (weda na human being, animal or anytin) den kon chop dis ofrin meat wey dem give God, dem go remove di pesin from di kommunity.”
LEV 7:22 God tell Moses:
LEV 7:23 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Make una nor chop di fat wey dey kattle, sheep or goat.
LEV 7:24 Una must nor chop animal wey just die on en own or wey wiked animal kill, but una fit use di dead body do anoda tin.
LEV 7:25 Anybody wey chop animal wey dem offa as food ofrin to God, nor go dey among God pipol again.
LEV 7:26 E nor matter where Israel pipol dey stay, dem must neva use bird or animal blood take do food.
LEV 7:27 Anybody wey break dis law nor go dey among God pipol again.’ ”
LEV 7:28 God kon give Moses dis laws:
LEV 7:29 “Go tell Israel pipol sey, ‘Anybody wey give peace ofrin must bring part of am as special gift to God.
LEV 7:30 E go bring am with en own hand as food ofrin. E go bring di animal fat with en breast kon gi-am as special gift to God.
LEV 7:31 Di priest go burn di fat for di altar, but di breast go bi di priest own.
LEV 7:32 E go give di animal rite leg as special kontribushon
LEV 7:33 to di priest wey give di blood and di fat as peace ofrin.
LEV 7:34 Di animal breast na special gift and di rite leg na special kontribushon wey God don take from Israel pipol kon gi-am to di priests. Dis na wetin Israel pipol go give di priests forever.
LEV 7:35 Dis na part for di food wey dem give God, Aaron and en sons for di day wey dem make dem priest.
LEV 7:36 For dat day, God kommand Israel pipol make dem give dem dis part from di ofrin. Na law wey Israel pipol must obey forever.’ ”
LEV 7:37 Dis na di law for di burnt, korn, sin, guilt, ordinashon and di peace ofrin.
LEV 7:38 For Mount Sinai, God kon give dis kommand to Moses for di day wey e tell Israel pipol to give dia ofrin.
LEV 8:1 God tell Moses,
LEV 8:2 “Make yu take Aaron and en sons go di tent gate, bring dia garments, di anointin oil, di yong melu for di sin ofrin, di two ram and di basket of bread wey nor get yist.
LEV 8:3 Den gada di whole kommunity for der.”
LEV 8:4 Moses do as God kommand am and wen dem don gada,
LEV 8:5 e kon tell dem, “Dis na wetin God kommand sey make wi do.”
LEV 8:6 Moses bring Aaron and en sons kom out kon wosh dem with wota.
LEV 8:7 E wear di shirt and robe give Aaron kon tie di sash for en waist. E wear priest garment wey dem design for Aaron kon tie am with belt.
LEV 8:8 E wear di Breast Plate gi-am kon put di Urim and Tummim for inside.
LEV 8:9 E put di priest kap for en head kon put di gold plate wey bi di holy sign for en front, just as God kommand am.
LEV 8:10 Den Moses use di anointin oil take anoint di Tabanako and evritin wey dey inside, so dat e go dey holy.
LEV 8:11 E sprinkol some anointin oil for di altar seven times; plus di vessels, wosh-hand basin and dia stand, so dat all of dem go dey holy.
LEV 8:12 E pour some anointin oil for Aaron head, so dat e go dey holy.
LEV 8:13 Moses take Aaron sons go front, e wear dem di shirt, put sash round dia waist kon wrap dia head, just as God kommand.
LEV 8:14 E bring di yong melu for di sin ofrin, den Aaron and en sons kon put dia hand for di melu head.
LEV 8:15 Moses kill-am, take some of di blood with en finger kon put am round di horn for di altar and e pour di rest under di altar, so dat e go dey holy.
LEV 8:16 Moses take all di fat for di intestine, di best part for di liver, di two kidney with dia fat kon burn all of dem for di altar.
LEV 8:17 E take di remainin melu part, en skin, flesh and intestine kon go burn am outside di kamp, just as God kommand am.
LEV 8:18 Moses bring di ram for di burnt ofrin, den Aaron and en sons put dia hand for di ram head.
LEV 8:19 Moses kill-am kon rub di blood for di four side for di altar.
LEV 8:20 E kut di ram small-small kon burn di head, some part and di fat on-top di altar.
LEV 8:21 Afta Moses don wosh di intestine and di leg with wota, e kon burn all di ram on-top di altar as komplete ofrin. Na burnt ofrin wey dem give to God and God like am well-well. So, Moses do as God kommand am.
LEV 8:22 Den Moses bring di sekond ram wey dem go use take anoint di priests, den Aaron and en sons put dia hand for di animal head.
LEV 8:23 Moses kill-am kon take some of di blood put for Aaron rite ear, en big finger for en rite hand and for en big toe for en rite leg.
LEV 8:24 Den e take Aaron sons go front kon put some of di blood for dia rite ear, dia big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den Moses pour di remainin blood for di four side for di altar.
LEV 8:25 E take di fat (di fat tail, all di fat wey dey di intestine), di best part for di liver, di two kidney with dia fat and di animal rite leg.
LEV 8:26 Den e take one bread wey nor get yist from di basket wey dey God present; bread wey dem mix with olive oil and one biscuit kon put dem on-top di fat and di rite leg.
LEV 8:27 E put all dis food for Aaron and en sons hand and dem kon gi-am as special gift to God.
LEV 8:28 Den Moses take di food from dem kon burn am on-top di burnt ofrin for di altar and na di ordinashon ofrin e bi. God like dis food ofrin smell well-well.
LEV 8:29 Den Moses take di breast kon gi-am as special gift to God. Na Moses own part for di ordinashon ram, bi dat. Moses do all wetin God kommand am.
LEV 8:30 Moses take some anointin oil and some blood wey dey di altar kon sprinkol dem for Aaron, en sons and for dia garment. Na so e take klean dem and dia klot, so dat dem go dey holy to serve God.
LEV 8:31 Moses tell Aaron and en sons sey, “Make una boil di meat for di tent gate kon chop am for der with di bread wey dey di ordinashon ofrin basket, just as God kommand.
LEV 8:32 But make una burn di meat and bread wey remain.
LEV 8:33 Una nor go komot from di tent gate for seven days, until evritin wey dem go do for una ordinashon, don finish.
LEV 8:34 Na God kommand us sey make wi do wetin wi do today, so dat E go forgive us awa sin.
LEV 8:35 Una must stay for di tent gate for seven days and seven nite, so dat una nor go die. Dis na wetin God kommand.”
LEV 8:36 So Aaron and en sons kon do evritin wey God kommand thru Moses.
LEV 9:1 For di eight day, Moses koll Aaron and en sons and di leaders for Israel kon
LEV 9:2 tell Aaron, “Make yu take one yong melu and one ram wey dey okay kon give dem to God. Di melu go bi for sin ofrin, while di ram na for burnt ofrin.
LEV 9:3 Den yu go tell Israel pipol sey, ‘Make dem take one goat for sin ofrin, one melu and one lamb wey bi one year wey dey okay kon use dem as burnt ofrin,
LEV 9:4 den dem go take one melu and ram for peace ofrin. Dem go sakrifice dem give God with di korn ofrin wey dem mix with olive oil. Dem must do am, bikos God go appear to dem today.’ ”
LEV 9:5 So dem take evritin wey Moses kommand go di tent front and di whole kommunity gada for der kon woship God.
LEV 9:6 Den Moses tell dem, “Dis na wetin God kommand una to do, so dat di lite wey dey shine for en present, go appear to una.”
LEV 9:7 Den Moses tell Aaron, “Make yu go di altar go offa di sin ofrin and di burnt ofrin, so dat God go forgive una and di pipol. Make yu do di ofrin for di pipol, so dat God go forgive una just as E don kommand.”
LEV 9:8 Aaron go di altar kon kill di yong melu for en own sin ofrin.
LEV 9:9 En sons karry di blood gi-am, den e shuk en finger put kon put am for di horn wey dey di altar and e pour di remainin ones under di altar.
LEV 9:10 E burn di fat for di altar, di two kidney and dia fat and di best part for di liver, just as God kommand Moses.
LEV 9:11 But e burn di meat and di skin for outside di kamp.
LEV 9:12 E kill di animal wey dem won use for burnt ofrin. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar.
LEV 9:13 Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar.
LEV 9:14 E wosh di intestine and di leg kon burn dem for di altar on-top di remainin burnt ofrin.
LEV 9:15 Afta, e kon do ofrin for di pipol. E take di goat wey dem give for di pipol sin kon kill-am and e first do en own sin ofrin.
LEV 9:16 E still bring di animal for di burnt ofrin kon gi-am akordin to di law.
LEV 9:17 E give di korn ofrin; pak flower full en hand kon burn am for di altar. (Dem go dey add dis one join di burnt ofrin evriday.)
LEV 9:18 E kill di melu and di ram as peace ofrin for di pipol. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar.
LEV 9:19 Aaron put di melu fat and di ram
LEV 9:20 on-top di animal breast kon karry all go di altar. E burn di fat for di altar
LEV 9:21 kon give di breast and di rite leg as special gift to God for di priests, just as Moses kommand.
LEV 9:22 So, Aaron bless di pipol wen e don finish all di sakrifice.
LEV 9:23 Moses and Aaron enter di tent and wen dem kom out, dem kon bless di pipol, den di lite wey dey shine for God present kon appear to di pipol.
LEV 9:24 At wons, God send fire go burn di burnt ofrin and di fat dem for di altar. Wen di pipol si am, dem kon shaut and bow face groun.
LEV 10:1 Den Aaron sons, Nadab and Abihu kon take fire pan, put fire and incense inside kon give God anoda ofrin wey E nor kommand dem.
LEV 10:2 So fire kom out from God present kon burn dem die.
LEV 10:3 Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.
LEV 10:4 Den Moses koll Mishael and Elzafan wey bi Aaron papa broda Uzziel pikin kon tell dem, “Make una kom karry una brodas body komot from di sanctuary go beri outside di kamp.”
LEV 10:5 So dem karry dem komot with dia tunik go outside di kamp, just as Moses tok.
LEV 10:6 Den Moses tell Aaron and en two oda sons, Eleazar and Itama sey, “Make una nor barb una hair or tear una klot to show sey una dey mourn. If una do am, una go die and God go vex for di kommunity. But Israel pipol fit mourn, bikos God kill Nadab and Abihu.
LEV 10:7 But una nor go komot from di tent gate or una go die, bikos di anointin oil don make una dey holy for God present.” So dem kon do wetin Moses tell dem.
LEV 10:8 Den God tell Aaron,
LEV 10:9 “Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.
LEV 10:10 Yu go separate wetin bi God own from human being own; wetin holy from wetin nor dey holy.
LEV 10:11 Yu must tish di pipol all di laws wey I don give yu thru Moses.”
LEV 10:12 Moses kon tell Aaron and en two sons Eleazar and Itama sey, “Make una use di korn ofrin wey remain from di food wey dem offa give God, take make bread wey nor get yist, den chop am for di altar side, bikos na holy ofrin.
LEV 10:13 Make una chop am for di Holy Place, bikos dat na yu and yor sons own. Dis na wetin God kommand.
LEV 10:14 Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give.
LEV 10:15 Dem go bring di leg and di breast wen dem won give as food ofrin to God. Dis part na yu and yor shidren own forever, just as God don kommand.”
LEV 10:16 Moses ask for di goat wey dem take do sin ofrin, but dem tell am sey dem don already burn am. E vex for Eleazar and Itama kon ask,
LEV 10:17 “Why una nor chop di sin ofrin for where dey holy? Na bikos e dey holy well-well naim make God give una make E for forgive di kommunity dia sins.
LEV 10:18 Since dem nor bring di animal blood kom di holy tent, den una for chop di sakrifice for der, just as I kommand!”
LEV 10:19 Aaron ansa, “If I chop di sin ofrin today, God go happy with mi? Bikos even doh di pipol give God dia sin and burnt ofrin today, all dis bad tins still dey happen to mi.”
LEV 10:20 Wen Moses hear dis tin, e nor kon vex again.
LEV 11:1 God tell Moses and Aaron,
LEV 11:2 “Make una tell Israel pipol sey: ‘Among all di animal wey dey di land, dis na di ones wey una fit chop.
LEV 11:3 Una fit chop animal wey get two toes and dey re-shop grass wey e don swallow.
LEV 11:4 But make una nor chop animal wey dey re-shop grass but nor get two toes: Kamel nor dey klean, bikos e dey re-shop grass, but e nor get two toes.
LEV 11:5 Doz animals wey dey stay for rock nor dey klean, bikos dem dey chop dia vomit, even doh dem nor get two toes.
LEV 11:6 Hare nor dey klean, bikos e dey chop en vomit, even doh e nor get two toes.
LEV 11:7 Pig nor dey klean, bikos e get two toes, but e nor dey chop en vomit.
LEV 11:8 Make una nor chop dis meat or tosh dia dead body; bikos dem nor dey klean.
LEV 11:9 “ ‘Dis na di animal for wota wey una fit chop: Any animal wey get both fin and skale, weda e dey sea or river.
LEV 11:10 But make una nor chop anytin for wota wey nor get fin or skale.
LEV 11:11 Since una dey forbid am, make una nor chop dia meat or tosh dia dead body.
LEV 11:12 Any animal for wota wey nor get fin and skale, make una nor chop or tosh en dead body.
LEV 11:13 “ ‘Dis na di bird wey una nor suppose chop. Make una nor ever chop any kind vulture,
LEV 11:14 kite, buzzard,
LEV 11:15 crow,
LEV 11:16 di eagle owl, owl wey en ear short or long, any kind hawk,
LEV 11:17 small owl, kormorant, great owl,
LEV 11:18 white owl, owl for wildaness, Egypt owl,
LEV 11:19 stork, any kind heron, hoopoe and bat.
LEV 11:20 “ ‘All di insect wey get feada nor dey klean, dem nor dey good for una.
LEV 11:21 But una fit chop insect wey get four leg and dey jump for land.
LEV 11:22 Una fit chop lokust, cricket and grasshoppa.
LEV 11:23 But all di oda animal for groun wey get feada nor dey good for una.
LEV 11:24 “ ‘Anybody wey tosh unklean animal dead body don spoil ensef and dat pesin go dey unklean till evening.
LEV 11:25 Anybody wey karry dia dead body, go-go wosh en klot and e go dey unklean till evening.
LEV 11:26 “ ‘All di animal wey get toe wey nor divide into two finish and dem nor dey re-shop dia food, dey unklean to una. Anybody wey tosh dem don dey unklean.
LEV 11:27 All di animal wey dey waka with four legs, doz wey get finger, dey unklean to una. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening
LEV 11:28 and di pesin wey karry dia body, go-go wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis animals nor dey good for una.
LEV 11:29 “ ‘Naw, dis na di tins wey dey unklean among di animal wey dey stay land: rat, any kind big lizard,
LEV 11:30 krokrodie, lizard wey get spot for body, wall-deko for house and kameleon wey en kolour dey shange.
LEV 11:31 Dis na di ones wey dey unklean among di animals for land. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening.
LEV 11:32 Anytin wey dem fall put wen dem die go dey unklean; weda na wood, klot, leda or sak. Doz tins nor dey yuzful again. Even wen dem deep am for wota, e go still dey unklean till evening.
LEV 11:33 “ ‘And if dia body fall inside pot wey bi klay, evritin wey dey inside di pot go dey unklean and una must break di pot.
LEV 11:34 If di wota from di pot tosh any food wey una suppose chop or wota wey una won drink, den evritin don dey unklean.
LEV 11:35 Anytin wey dia dead body fall put go dey unklean. Weda na stove or oven, dem go break am to pieces.
LEV 11:36 “ ‘Wota wey dem fetch from spring dey klean, but if dia dead body tosh di pot, e go dey unklean.
LEV 11:37 If any one fall for any seed wey dem won plant, dem go plant am and e go dey klean.
LEV 11:38 But if dem put wota for di seed and one dead body fall put, e go dey unklean.
LEV 11:39 “ ‘If any animal wey yu suppose chop die on en own, anybody wey tosh en dead body go dey unklean till evening.
LEV 11:40 If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.
LEV 11:41 “ ‘Una must nor chop any animal wey dey creep for groun,
LEV 11:42 weda dem dey creep or waka with four leg or dem get many legs.
LEV 11:43 If una chop any of dis animals, una nor go dey klean.
LEV 11:44 I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef.
LEV 11:45 Na mi bi God wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God and una go dey holy, bikos I dey holy.
LEV 11:46 “ ‘Dis na di law for di animal wey dey land; di birds, all di animals for wota and doz ones wey dey creep for land.
LEV 11:47 And dis law na to separate between wetin dey klean and wetin nor dey klean, so dat pipol go know di animals wey dem suppose chop and di ones wey dem nor go chop.’ ”
LEV 12:1 God tell Moses:
LEV 12:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen woman born and di pikin na boy, e go dey unklean for seven days, bikos di mama nor dey klean wen e dey mestrate.
LEV 12:3 For di eight day, dem go sekonsaiz di pikin.
LEV 12:4 Bikos of di blood wey e lost, di woman go stay for thirty-three days, before e go dey klean. E must nor tosh anytin wey dey holy and e nor go enter di Tabanako, until di day wey dem go santify am, don komplete.
LEV 12:5 If e born girl, e go dey unklean for fourteen days as e bi wen e dey mestrate and e go stay for sixty-six days, before e go dey klean.
LEV 12:6 “ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin.
LEV 12:7 Di priest go give God di ofrin kon do di sakrifice, so dat e go dey holy. Dis na wetin di woman go do afta e don born.
LEV 12:8 “ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”
LEV 13:1 God tell Moses and Aaron:
LEV 13:2 “If anybody get sore, boil or spot and e turn to diziz for en skin, dem must karry am go meet Aaron wey bi di priest or en sons.
LEV 13:3 Di priest go look di sore and if di hair wey dey en skin don turn white and di sore deep well-well pass di skin, di priest go sey di pesin nor dey klean.
LEV 13:4 “But if di sore dey white and e nor deep pass di skin and di hair neva shange to white, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
LEV 13:5 Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days.
LEV 13:6 Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean.
LEV 13:7 But if di sore spread afta di priest don look am sey e klean, e must go meet di priest again.
LEV 13:8 Di priest go look am again and if e si sey e don spread, e go sey e nor dey klean, bikos na diziz e get.
LEV 13:9 “If anybody get diziz for en skin, dem go take am go meet di priest and
LEV 13:10 e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus,
LEV 13:11 na sirious diziz e get for en skin. Di priest go sey e nor dey klean.
LEV 13:12 “If di diziz for di skin spread kover all en body,
LEV 13:13 di priest go look am again. If e si sey e don really kover en whole body, e go kon sey di pesin klean. If all en skin turn to white, den e dey klean.
LEV 13:14 But if new sore bigin show, den e nor dey klean.
LEV 13:15 Di priest go look am again and if e si new sore wey open for en skin, e go sey e nor dey klean. Sore wey open mean skin diziz wey fit kill pesin. So di pesin nor dey klean at-all.
LEV 13:16 But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest,
LEV 13:17 wey go look am again. If di sore don turn white, den di priest go sey e don klean.
LEV 13:18 “If anybody get boil wey don heal,
LEV 13:19 den di boil kon swell-up and white or red-white spot kon appear for where di boil dey before, e go-go meet di priest.
LEV 13:20 Di priest go look am and if di spot deep pass di skin wey near where di boil dey and di hair dem wey dey der kon turn white, e go sey di pesin nor dey klean. Na skin diziz wey dem dey fear well-well.
LEV 13:21 If di priest look am kon si sey di hair wey dey der neva turn white and e nor deep pass di skin, but e get lite kolour, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
LEV 13:22 If di spot spread, di priest go sey di pesin nor dey klean; e get diziz.
LEV 13:23 But if e nor shange or spread and na only di mark dey show, di priest go sey e dey klean.
LEV 13:24 “Wen sometin like fire burn pesin, if di flesh shange to white or red-white,
LEV 13:25 di priest go look am. If di hair for di spot don turn white and e deep pass di skin wey dey near am, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well and di priest go sey e nor dey klean.
LEV 13:26 But if di hair for where di spot dey turn white and e nor deep pass di skin wey dey near am, but e get lite kolour, di priest go separate am from oda pipol for seven days.
LEV 13:27 Di priest go look am again for di sevent day and if e dey spread, di priest go sey e nor dey klean.
LEV 13:28 But if di spot nor shange, spread and e get lite kolour, den nor bi skin diziz. Di priest go sey e dey klean, bikos na just mark from di fire wey burn am.
LEV 13:29 “Wen man or woman get sore for head or for di bear-bear side,
LEV 13:30 di priest go look am. If e deep pass di skin wey dey near am and di hair dem dey yellow and tin, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well, so di priest go sey di pesin nor dey klean.
LEV 13:31 If di priest look am kon si sey di sore nor deep pass di skin wey dey near am and e nor get black hair, di priest go separate am from oda pipol for seven days.
LEV 13:32 Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am,
LEV 13:33 den di pesin go barb en hair kon leave only di place where di sore dey. Di priest go separate am from oda pipol for anoda seven days.
LEV 13:34 For di sevent day, di priest go look di sore again and if e neva spread and e nor deep pass di skin wey dey near am, di priest go sey di pesin dey klean. So e go wosh en klot kon dey klean.
LEV 13:35 But if di sore spread afta di priest don sey e dey klean,
LEV 13:36 di priest go look am again. If di sore don spread, e nor nid to look for hair wey yellow; di pesin nor dey klean bi dat.
LEV 13:37 But if di priest feel sey di sore neva spread and black hair dey grow for inside, dat mean sey di sore don heal, den di pesin don klean.
LEV 13:38 “Wen man or woman get white spot for en skin,
LEV 13:39 di priest go look di pesin. If di white spot wey dem get for body na white wey don fade, den na rashes from di pesin skin and e dey klean.
LEV 13:40 “If man nor get hair for back of en head, e dey klean.
LEV 13:41 If man nor get hair for front of en head, e dey klean.
LEV 13:42 But if rashes wey dey red dey for di back or di front wey hair nor dey, den dat na diziz.
LEV 13:43 Di priest go look am, if di diziz na di one wey dey red and white for di back or for di front where hair nor dey,
LEV 13:44 den di man don get strong diziz bi dat. E nor dey klean. Di priest must sey di man nor dey klean, bikos of di diziz wey dey en back head.
LEV 13:45 “As for di pesin wey get di diziz, dem must tear e klot; nor komb en hair and e go kover en face dey shaut sey, ‘I nor dey klean! My body dirty well-well!’
LEV 13:46 As long as e get dis diziz, e go dey unklean and una go keep am for where pipol nor dey-dey for outside di kamp.
LEV 13:47 “Wen klot get diziz, weda na wool or linen klot,
LEV 13:48 or any pieces of linen or wool, or di leda or anytin wey dem take leda make,
LEV 13:49 if di diziz wey dey di klot or leda na yellow wey dey green or red, den dem must show di priest.
LEV 13:50 Di priest go look di tins well-well kon keep am for outside for seven days.
LEV 13:51 E go shek am again for di sevent day. If di diziz don spread for di klot, wrapa or leda, den di klot nor dey klean bi dat.
LEV 13:52 Di priest go burn am with fire, bikos of di diziz wey spread for di klot.
LEV 13:53 “But wen di priest shek and di diziz neva spread for di klot,
LEV 13:54 e go sey make dem wosh and keep am for anoda seven days.
LEV 13:55 Den e go look am again, if di diziz neva shange kolour, even if e nor spread e go still dey unklean; den una must burn di klot, weda di stain dey for back or front.
LEV 13:56 But if di priest look kon si sey di diziz don fade, e go tear dat part komot for di klot or di leda.
LEV 13:57 Den if di diziz kom back kon spread again, di pesin wey get di klot go burn am.
LEV 13:58 If e wosh di klot and di spot dem komot, e go wosh am again and e go dey klean.”
LEV 13:59 Dis na di law about diziz wey dey inside klot, weda na wool, linen or leda and na like dis dem go take know weda e dey klean or not.
LEV 14:1 God tell Moses:
LEV 14:2 “For di day wen di priest won klean di pesin wey bin get diziz, dis na di tins wey e go do.
LEV 14:3 Di priest go-go outside di kamp go look di pesin. If di pesin wey get di diziz don dey okay,
LEV 14:4 di priest go orda sey make dem bring two klean bird, part for cedar wood, red rope and some hyssop leaf.
LEV 14:5 Di priest go orda sey make dem kill one bird put for klay pot wey dem just fetch wota put.
LEV 14:6 Di bird wey dem kill and put en blood for klean wota, di priest go take di oda bird with di cedar wood part, di red rope and hyssop leaf kon deep dem inside am.
LEV 14:7 Den e go sprinkol am seven times for di pesin wey dem dey santify kon sey e dey klean and e go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field.
LEV 14:8 “Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days.
LEV 14:9 For di sevent day, e go barber en hair again, en bear-bear, di hair wey dey en eye and all di hair wey dey en body. E go still wosh en klot kon baf, den e go dey klean.
LEV 14:10 “For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.
LEV 14:11 Di priest go take di pesin and di ofrin go di tent for God present.
LEV 14:12 Di priest go take one man lamb with di olive oil kon offa am as guilt and sin ofrin to God.
LEV 14:13 Den e go kill di man lamb for di place where dem for dey kill lamb for sin and burnt ofrin. E must do dis tin, bikos na di priest get di sin and guilt ofrin and dem dey holy.
LEV 14:14 Den di priest go take some blood for di lamb kon put am for di pesin wey dem dey santify rite ear; en big finger for en rite hand and en big toe for en rite leg.
LEV 14:15 Di priest go take some olive oil pour for en left hand,
LEV 14:16 deep en rite finger inside, den dem go sprinkol am seven times for God present.
LEV 14:17 E go take some oil wey dey en hand and some blood for di lamb kon put dem for di pesin wey dem dey santify rite ear; di big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
LEV 14:18 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head. Na like dis di priest go take make di pesin dey holy for God eye.
LEV 14:19 Di priest go offa di sin ofrin kon beg God for di pesin wey dem dey santify and afta dat one, e go kill di animal for di burnt ofrin
LEV 14:20 kon offa di burnt and korn ofrin for di altar. So di priest go beg God for am and e go dey holy.
LEV 14:21 “If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil.
LEV 14:22 E go still bring two dove or two pijin, one for di sin ofrin and one for di burnt ofrin.
LEV 14:23 For di eight days wey e go take klean ensef, e go give di priest all dis tins for di tent gate.
LEV 14:24 Di priest go take di lamb and di olive oil as special gift to God.
LEV 14:25 E go kill di lamb kon take some of di blood put for di pesin rite ear, en big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
LEV 14:26 “Di priest go pour some oil for en left hand
LEV 14:27 and with one finger wey dey en rite hand, e go sprinkol am seven times for God present.
LEV 14:28 E go put some of di oil for di same place just as e put di blood before for di pesin rite ear, di big finger for en rite hand and for di big toe for en rite leg.
LEV 14:29 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head and like dis, e dey make di pesin holy.
LEV 14:30 Den e go offa one dove or pijin
LEV 14:31 as sin ofrin and di oda go bi for burnt ofrin with di korn ofrin. Like dis, di priest go beg for di pesin wey e dey santify before God.
LEV 14:32 Dis law na for poor pesin wey get diziz, wey nor fit pay or do di normal ofrin.”
LEV 14:33 God tell Moses and Aaron:
LEV 14:34 “Wen una don enter di land wey dey Kanaan wey I go give una to stay and I kon put diziz for di house wey una won stay,
LEV 14:35 den who get di house go kom show ensef to di priest sey, ‘I si sometin wey bi like diziz for my house.’
LEV 14:36 Den di priest go orda sey make dem santify di house before di priest go enter go look am.
LEV 14:37 E go look di diziz and if di diziz wey dey di wall for di house dey yellow, green or red,
LEV 14:38 e go leave di house kon lock am for seven days.
LEV 14:39 For di sevent day, e go-go back go look am again. If di diziz don spread,
LEV 14:40 e go orda make dem remove di stones wey di diziz dey and dem go trow am for outside di town.
LEV 14:41 Afta dat, e go klean di wall kon trow di dirty outside di town.
LEV 14:42 Dem go use anoda stone take shange di stones wey dem remove, den dem go plasta di wall.
LEV 14:43 “If di diziz kom out again afta dem don remove di stone kon plasta am,
LEV 14:44 di priest go-go look am, if di diziz don spread, den di house nor dey klean bi dat.
LEV 14:45 Dem must distroy di house, en stones and wood kon trow dem outside di town.
LEV 14:46 Anybody wey enter di house for di time wey dem lock am go dey unklean till evening.
LEV 14:47 Anybody wey liedan or chop for di house must go wosh en klot.
LEV 14:48 If di priest kom look and di diziz nor kom back again afta dem don plasta di wall, e go sey di house dey klean, bikos di diziz don go.
LEV 14:49 To santify di house, e go take two birds, cedar wood, red rope and hyssop leaf
LEV 14:50 kon kill one of di bird put inside klay pot wey dem just fetch wota put.
LEV 14:51 E go take di cedar wood, di red rope, di hyssop leaf and di bird wey dey alive, deep dem inside di blood kon sprinkol am for di house seven times.
LEV 14:52 Like dis, e go santify di house from di diziz with di bird blood; di klean wota; di bird wey dey alive, di cedar wood, di hyssop leaf and di red rope.
LEV 14:53 E go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field. Na like dis di priest go take santify di house and e go dey klean.
LEV 14:54 “Dis na di law for skin diziz;
LEV 14:55 diziz for klot and house;
LEV 14:56 di ones wey swell-up for body and di spot wey dem dey si.
LEV 14:57 Dis law na to know wetin dey klean or not.”
LEV 15:1 Den God tell Moses and Aaron:
LEV 15:2 “Make una go tell Israel pipol sey, ‘Wen man discharge, e go dey unklean, bikos of dat tin.
LEV 15:3 Weda di tin dey komot from en body or e don stop, di man don dey unklean.
LEV 15:4 Any bed wey e liedan or sidan put, don dey unklean.
LEV 15:5 “ ‘Anybody wey tosh di bed wey di man liedan put must go wosh en klot kon baf with wota and di pesin go dey unklean till evening.
LEV 15:6 Anybody wey sidan for di chair wey di pesin wey discharge sidan put before, must wosh en klot, baf with wota and e go dey unklean till evening.
LEV 15:7 Anybody wey tosh am must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.
LEV 15:8 If di pesin wey discharge, spit for pesin wey dey klean body, dat pesin must go wosh en klot kon baf, but e go dey unklean till evening.
LEV 15:9 Anytin wey dem dey ride or chair wey di pesin sidan put go dey unklean.
LEV 15:10 Anybody wey tosh wetin e sidan put go dey unklean till evening. Anybody wey karry wetin di pesin sidan put must go wosh en klot, baf, but e go still dey unklean till evening.
LEV 15:11 Anybody wey tosh di man wey discharge and e nor wosh en hand, must go wosh en klot and baf with wota, but e go still dey unklean till evening.
LEV 15:12 If di man tosh klay pot, dem must break am and if na plate wey dem make with wood naim di man tosh, dem must wosh am.
LEV 15:13 “ ‘Wen di man wey discharge don klean, e go wait for seven days, wosh en klot kon baf with fresh wota and e go dey klean.
LEV 15:14 For di eight day, e go take two dove or two pijin kom di tent gate for God present kon give dem to di priest.
LEV 15:15 Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.
LEV 15:16 “ ‘Wen di man discharge, e must go baf, but e go dey unklean till evening.
LEV 15:17 Anytin wey dem do with klot or leda and di discharge tosh am, dem must wosh am and di tin go dey unklean till evening.
LEV 15:18 Afta di man don sleep with di woman finish, di man and di woman must go baf and dem go dey unklean till evening.
LEV 15:19 “ ‘Wen woman dey mestrate, e go dey unklean for seven days. Anybody wey tosh am go dey unklean till evening.
LEV 15:20 Anytin wey e sidan or liedan put wen e dey mestrate, go dey unklean.
LEV 15:21 Anybody wey tosh di bed wey e sleep put must wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
LEV 15:22 Anybody wey tosh di chair wey e sidan put must go wosh e klot, baf with wota and e go dey unklean till evening.
LEV 15:23 If anytin dey for di bed or di chair wey e sidan put, wen e tosh am e go dey unklean till evening.
LEV 15:24 If man sleep with am for dat time, e go dey unklean for seven days and any bed wey di man sleep put, go dey unklean too.
LEV 15:25 “ ‘Wen di woman dey mestrate before di rite time or if di blood still dey flow wen e suppose don stop, e go dey unklean as far as di blood still dey flow.
LEV 15:26 Any bed wey e sleep or anytin wey e sidan put, go dey unklean for dat time.
LEV 15:27 Anybody wey tosh dem, dey unklean and e must go wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
LEV 15:28 “ ‘Wen di blood don stop, di woman go wait for seven days, den e go dey klean.
LEV 15:29 For di eight day, e go take two dove and two pijin go give di priest for di tent gate for God present.
LEV 15:30 Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin, na like dis di priest go take make sakrifice before God.’ ”
LEV 15:31 God tell Moses make e warn Israel pipol about dia dirty life, so dat dem nor go spoil God house wey dey di kamp centre. If dem do am, dem go die.
LEV 15:32 “Dis law na for men wey dey discharge,
LEV 15:33 woman wey dey mestrate or man wey sleep with woman wey nor klean.”
LEV 16:1 God tell Moses afta Aaron sons don die bikos dem offa strenj fire to God:
LEV 16:2 “Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
LEV 16:3 “E go fit enter di place wey holy well-well only afta e don bring one yong melu for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.
LEV 16:4 Before Aaron go enter di place wey holy pass, e must baf and wear di garment wey priests dey wear; wey bi linen robe and short nika, both di belt and di priest kap.
LEV 16:5 Israel pipol go give Aaron two man goat for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.
LEV 16:6 “E go give one melu as sakrifice make God for forgive en and en family dia sins.
LEV 16:7 Den e go take di two goat go di door-mot for di tent where dem for dey do meetin.
LEV 16:8 E go trow dice kon mark one goat sey, ‘Dis one go bi ofrin to God’ and di oda goat go karry di pipol sin go Azazel wildaness.
LEV 16:9 Aaron go sakrifice di goat wey dem choose thru di dice wey dem trow kon gi-am as sin ofrin.
LEV 16:10 Dem go give di life goat wey dem choose for Azazel to God kon send am komot go Azazel for di wildaness, so dat God go forgive di pipol dia sin.
LEV 16:11 “Wen Aaron sakrifice di melu as sin ofrin for ensef and en family,
LEV 16:12 e go take fire pan with plenty shako from di altar kon pak fine incense full hand, den e go take am go di place wey holy well-well.
LEV 16:13 For God present, e go put di incense for fire and di smoke wey dey kom out from di incense go kover di Kovenant Box make e for nor si am kon die.
LEV 16:14 E go take some of di melu blood with en finger kon go sprinkol am for di east side for di forgivenes plate, den e go rub am seven times for di Kovenant Box front.
LEV 16:15 “Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood.
LEV 16:16 Na like so e go take do sakrifice for di Holy Place for Israel pipol sin. E go still do sakrifice for di tent, bikos di tent dey centre for di kamp even as dem nor dey holy.
LEV 16:17 From di time wey Aaron enter di place wey holy well-well go do di sakrifice, go rish wen e go kom out, nobody must dey inside di tent. Wen e don do sakrifice for ensef, en family and di whole kommunity,
LEV 16:18 den e must go di altar wey dey before God kon santify am. E must take some of di melu and goat blood kon put am for front for di altar korna.
LEV 16:19 E must use en finger take rub some of di blood for di altar seven times. Na so e go take santify di altar from Israel pipol sin, so dat dem go dey holy.
LEV 16:20 “Wen Aaron don do di sakrifice to take santify di place wey holy well-well, where dem for dey do meetin and di altar, e go give God di goat wey still dey alive wey dem choose for Azazel.
LEV 16:21 E go put en two hand for di goat head kon konfess all Israel pipol evil, sin and sturbones for di goat head, den drive am go di wildaness.
LEV 16:22 Di goat go karry all dia sin go anoda land wey pipol nor dey.
LEV 16:23 “Den Aaron go-go di tent, komot di priest garment wey e wear before e enter di place wey holy well-well kon leave dem for der.
LEV 16:24 E must baf for di holy place kon wear en own klot. Afta dat, e go komot go give di burnt ofrin for en and di pipol sin.
LEV 16:25 Di animal fat for di sin ofrin, e go burn am for di altar.
LEV 16:26 “Di man wey drive di goat go Azazel for di wildaness, must wosh en klot and baf, before e go kom back to di kamp.
LEV 16:27 “Di melu and di goat wey dem use for di sin ofrin, so dat Israel pipol go dey klean from sin, dem go karry dia blood go di place wey holy pass kon burn dem for outside. Dem go burn dia skin, meat and intestine.
LEV 16:28 Di pesin wey burn dem go wosh en klot kon baf before e go-go back to di kamp.
LEV 16:29 “Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.
LEV 16:30 For dat day, dem go do sakrifice, so dat una go dey klean for God eye.
LEV 16:31 Dat day go dey very holy, dem go fast and dem nor go do any work at-all. Dem go keep dis law forever.
LEV 16:32 Di priest wey dem choose as High Priest to serve wen en papa nor dey, na-im go do di sakrifice. E go wear di priest garment
LEV 16:33 kon santify di place wey holy well-well, where dem for dey do meetin, di altar, di priests and all di pipol for Israel.
LEV 16:34 Dis na di law wey una go obey forever. Dem must do dis sakrifice wons for evry year to take santify Israel pipol from all dia sins.” So Moses do as God kommand am.
LEV 17:1 God tell Moses:
LEV 17:2 “Go tell Aaron, en sons and Israel pipol sey: ‘Dis na wetin God tok:
LEV 17:3 Anybody wey kill animal like melu, sheep or goat among Israel house for dia kamp
LEV 17:4 and e nor take am go di tent gate as ofrin to God, e don kill bi dat and e nor go dey among Israel pipol again.
LEV 17:5 Like dis, wetin Israel pipol won sakrifice for di open field to God for di tent gate, dem go gi-am to di priest, den e go sakrifice am as peace ofrin to God.
LEV 17:6 Di priest go pour di blood for God altar for di tent kon burn di fat and God like dis ofrin smell.
LEV 17:7 So make di pipol nor sin against God kon offa sakrifice give dia goat juju. Israel pipol must keep dis law forever.
LEV 17:8 “ ‘Any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land wey offa burnt ofrin or any oda sakrifice
LEV 17:9 as ofrin to God for any place escept di tent gate, nor go dey among God pipol again.
LEV 17:10 “ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.
LEV 17:11 Bikos na blood bi life for di body, naim make God sey dem must pour all di blood for di altar to take santify pipol. Blood wey bi life, dey remove sin.
LEV 17:12 Na dis make God tell Israel pipol and all di strenjas wey dey stay for dia land sey make dem nor chop meat wey still get blood.
LEV 17:13 “ ‘If anybody from Israel or strenja wey dey di land kill any animal or bird wey klean, e must pour di blood for groun kon kover am with san.
LEV 17:14 Na blood dey give life and na dis make God tell Israel pipol make dem nor chop meat wey still get blood and anybody wey do am, nor dey among God pipol again.
LEV 17:15 Anybody wey kom from Israel or strenja wey chop animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.
LEV 17:16 If e nor wosh e klot or baf, e go sofa di ponishment.’ ”
LEV 18:1 God tell Moses:
LEV 18:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi di Oga una God.
LEV 18:3 Make una nor do wetin una do for Egypt where una dey before or for Kanaan land wey I go soon give una or do wetin dia law tok.
LEV 18:4 Una must always keep my law and do wetin I tok. Na mi bi di Oga una God.
LEV 18:5 So una must keep my law and kommandment; anybody wey do like dat, go get long life. Na mi bi God.
LEV 18:6 “ ‘Make nobody sleep with en family memba, bikos na mi bi God.
LEV 18:7 Make una nor sleep with una mama, bikos una don disgrace una papa bi dat. Di woman na yor mama, so yu must nor sleep with am.
LEV 18:8 Make una nor go sleep with una papa wife, bikos na una papa nakednes.
LEV 18:9 “ ‘Make una nor go sleep with una sista, weda na una papa or mama pikin; or weda dem born am for di same house or outside; una must not sleep with dem.
LEV 18:10 “ ‘Make una nor sleep with una grand-pikin, weda di girl na yor son pikin or yor dota pikin, bikos dis go make yu disgrace yorsef.
LEV 18:11 Make una nor sleep with una step sista, or di girl pikin wey una papa wife born, bikos di girl na yor sista.
LEV 18:12 Make una nor sleep with una papa sista; bikos na yor papa flesh, e bi.
LEV 18:13 Make una nor sleep with una mama sista, bikos na yor mama flesh, e bi.
LEV 18:14 Make una nor sleep with una papa broda wife kon disgrace di man, bikos di woman na una aunty.
LEV 18:15 Make una nor sleep with una pikin wife; bikos na una pikin wife e bi.
LEV 18:16 Make una nor sleep with una broda wife, bikos una go disgrace una broda.
LEV 18:17 “ ‘Make una nor sleep with both mama and dota. And make una nor sleep with di woman grand-pikin, weda na en son or dota born am. Dem bi klose family and dis tin dey wiked well-well.
LEV 18:18 “ ‘As long as yor wife dey alive, nor marry en sista as sekond wife kon sleep with am, bikos dem go hate demsef.
LEV 18:19 “ ‘Make una nor sleep with any woman wey dey mestrate.
LEV 18:20 “ ‘Make una nor sleep with anoda man wife, bikos e nor good and e go make una dey unklean.
LEV 18:21 “ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.
LEV 18:22 “ ‘Make man nor sleep with man as if na woman; bikos dat kind tin dey bad for God eye.
LEV 18:23 “ ‘No man or woman must sleep with any animal, bikos e go make dem dey unklean.
LEV 18:24 “ ‘Make una nor spoil unasef with dis tins, bikos di pipol wey I dey drive komot for una, don spoil demsef with all dis tins.
LEV 18:25 Di whole land don dey unklean and I don ponish dem for dia sin, so di land don rijet di pipol wey dey stay der.
LEV 18:26 Una must obey all my law and kommand and una nor go do dis evil tins, both Israel pipol and doz wey bi strenjas,
LEV 18:27 bikos di pipol wey dey di land before, don do all dis evil tins and di land don dey unklean.
LEV 18:28 Make una nor make di land rijet una, bikos una spoil am, just as e rijet di pipol wey dey der before.
LEV 18:29 If anybody do dis evil tin, di pesin wey do dem nor go dey among my pipol again.
LEV 18:30 Una must obey my kommand and nor do any evil wey dem do before, so dat una nor go spoil unasef with dem. Na mi bi di Oga una God.’ ”
LEV 19:1 God tell Moses:
LEV 19:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.
LEV 19:3 Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.
LEV 19:4 Make una nor woship juju or make juju with iron. Na mi bi di Oga una God.
LEV 19:5 “ ‘Wen una won give una peace ofrin to God, una must sakrifice am well, so dat I go asept am.
LEV 19:6 Una must chop am for di day wey una sakrifice am or di next day, but una go burn di ones wey remain with fire for di third day,
LEV 19:7 bikos e don dey unklean. If anybody chop am, I nor go asept di ofrin.
LEV 19:8 Anybody wey chop am go dey guilty, bikos e trit wetin dey holy wey dem give to God like ordinary tin and e nor go dey among my pipol again.
LEV 19:9 “ ‘Wen una don gada di tins wey una harvest for una land, make una nor kut di korn wey dey di land front and make una nor go back go kut di korn wey remain.
LEV 19:10 Make una nor go una farm back go gada grape wey don dey yuzles or pick di grape wey fall for groun; but make una leave dem for poor pipol and strenjas. Na mi bi Oga una God.
LEV 19:11 “ ‘Make una nor play wayo, tif or lie.
LEV 19:12 Make una nor lie with my name kon promise pipol, bikos una go disgrace my name. Na mi bi di Oga una God.
LEV 19:13 Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.
LEV 19:14 Make una nor curse anybody wey nor dey hear or set trap for blind pesin. Una must fear una God; bikos na mi bi God.
LEV 19:15 “ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
LEV 19:16 Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.
LEV 19:17 Make una nor keep malice with anybody, but make una setol una kworel with dat pesin, so dat una nor go sin, bikos of dat pesin.
LEV 19:18 Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
LEV 19:19 Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.
LEV 19:20 “ ‘If man sleep with woman slave wey anoda man suppose marry and dem neva free or pay money for en head, den dem must pay evritin komplete. Dem nor go kill-am, bikos di woman na slave.
LEV 19:21 Di man go bring ram kom di tent gate for God present as guilt ofrin
LEV 19:22 and di priest go make sakrifice for am for di sin wey e kommit.
LEV 19:23 “ ‘Wen una enter di land kon plant tree for food, make una nor chop di first fruit wey e go bear. Make una nor chop am for di first three years.
LEV 19:24 For di fourt year, all en fruit go dey holy and e go bi praiz ofrin to God.
LEV 19:25 Den for di fift year, una fit chop di fruit wey e bear kon add am join una harvest. Na mi bi di Oga una God.
LEV 19:26 “ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.
LEV 19:27 Una must nor kut di hair wey kover una head or barb una bear-bear,
LEV 19:28 or draw picture for body; or kut mark to mourn pesin wey die. Na mi bi God.
LEV 19:29 Make una nor disgrace una girl pikin kon make am bi like ashawo; if una do like dat, di land go turn where ashawo and wiked pipol full.
LEV 19:30 “ ‘Make una keep di Sabat Day and honor di house where una for dey woship mi. Na mi bi God.
LEV 19:31 Make una nor go take advise from pipol wey dey serve dead pipol spirit. If una do am, una go dey unklean. Na mi bi Oga una God.
LEV 19:32 Make una dey respet and honor pipol wey senior una. Make una fear una God; Na mi bi God.
LEV 19:33 Make una nor ponish strenjas wey dey stay for una land.
LEV 19:34 Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God.
LEV 19:35 Make una nor play wayo wen una dey measure how sometin long and wide rish or oda tins wey many.
LEV 19:36 Make una dey measure well for evritin wey una dey do. Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt.
LEV 19:37 Make una obey all my laws and kommandment. Na mi bi God.’ ”
LEV 20:1 God tell Moses:
LEV 20:2 “Go tell Israel pipol sey, ‘Anybody among una wey give en girl pikin to Molek juju, dem must kill-am; di pipol wey dey di land must stone am die.
LEV 20:3 Mi mysef go turn my face against dat pesin kon remove am from my pipol, bikos e don give en pikin to Molek juju and like dat, e don spoil my temple kon disgrace my name.
LEV 20:4 If di pipol for di land nor do anytin or kill doz wey dey give dia pikin to Molek,
LEV 20:5 mi mysef go turn against dat man and en family. I go remove am from my pipol, both en and all di pipol wey follow am woship dat juju wey dem dey koll Molek.
LEV 20:6 “ ‘Di pesin wey dey go meet dead body spirit for advise, I go turn against am kon remove am from my pipol.
LEV 20:7 “ ‘Make una keep unasef holy, bikos na mi bi di Oga una God.
LEV 20:8 Make una obey my laws, bikos na mi bi God wey make una dey holy.
LEV 20:9 “ ‘If anybody curse en papa and mama, dem must kill-am and en blood go dey en own head, bikos e curse en papa and mama.
LEV 20:10 If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman.
LEV 20:11 If anybody sleep with en papa wife, e don disgrace en papa bi dat. So dem must kill both of dem and dia blood go dey for dia own head.
LEV 20:12 If anybody sleep with en pikin wife, dem must kill both en and di woman wey e sleep with. Dem don kommit evil and dia blood go dey for dia own head.
LEV 20:13 If man sleep with man like sey e dey sleep with woman, both of dem don kommit bad sin. So dem must kill two of dem and dia blood go dey for dia own head.
LEV 20:14 If anybody sleep with woman and en dota, dat kind tin bad well-well. So dem go burn di man, di woman and en dota with fire. So make una nor allow dis kind tin happen.
LEV 20:15 If any man sleep with animal, dem must kill di man and di animal.
LEV 20:16 If any woman sleep with animal, una must kill di woman and di animal and dia blood go dey for dia own head.
LEV 20:17 If anybody sleep with en own sista, weda na en papa or mama pikin and dem si each oda nakednes, na big disgrace e bi. Una must komot dem from where dia pipol dey. E don disgrace en sista, so e go bear di ponishment for en sin.
LEV 20:18 If any man sleep with woman wey dey si en mestrateshon kon naked am, e don break di law wey tok about holiness.
LEV 20:19 Make una nor naked una mama or papa sista, bikos anybody wey do like dat, go sofa di ponishment.
LEV 20:20 If anybody sleep with en uncle wife, e don disgrace en uncle, so e go sofa for en sin and e nor go born before e die.
LEV 20:21 E dey bad for man to sleep with en broda wife, bikos e don disgrace en broda; so e nor go born before e die.
LEV 20:22 “ ‘Make una make sure sey una obey all my law and kommand, so dat di land wey I won give una nor go rijet una.
LEV 20:23 Di pipol wey I dey porshu komot from di land for una, make una nor follow dia laws, bikos I nor like all di tins wey dem dey do.
LEV 20:24 So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas.
LEV 20:25 So una must separate di animal wey dey klean from di ones wey nor klean; di bird wey klean from di ones wey nor dey klean. Make una nor chop dem, bikos I don make una holy.
LEV 20:26 Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.
LEV 20:27 “ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
LEV 21:1 God tell Moses: “Make yu tell di priest wey bi Aaron sons sey, ‘For pesin wey don die, make any priest nor go dirty ensef bikos e go di burial.
LEV 21:2 But if di pesin dey klose to am like en: mama, papa, sista, broda,
LEV 21:3 and en sista wey bi virgin wey nor get husband, e fit go.
LEV 21:4 E must nor dirty ensef for somebody wey rilate to am only thru marriage.
LEV 21:5 Make di priest nor barb any part for en head, shave en bear-bear or kut en body.
LEV 21:6 Dem must dey holy to dia God and nor disgrace my name, bikos na dem dey offa food ofrin to mi.
LEV 21:7 Bikos di priests dey holy, dem must nor marry ashawo or woman wey nor bi virgin or woman wey leave en husband.
LEV 21:8 Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy.
LEV 21:9 If priest dota turn to ashawo, e dey bring disgrace for en papa; so dem go burn di girl.
LEV 21:10 “ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment.
LEV 21:11 E must nor go where dead body dey; e must nor make ensef unklean even for en papa or mama.
LEV 21:12 E must nor komot from di temple or enter where dead body dey, even if na en papa or mama die, bikos e don dey holy thru God anointin oil. Na mi bi Oga God.
LEV 21:13 Na only virgin di High Priest go fit marry.
LEV 21:14 E nor go marry woman wey en husband don die or wey leave en husband or woman wey dey do ashawo. En wife must bi virgin from en family.
LEV 21:15 If not, en shidren wey suppose dey holy go kon dey unklean. Na mi bi God and I don separate am as my High Priest.’ ”
LEV 21:16 God tell Moses:
LEV 21:17 “Go tell Aaron sey, ‘Make no man from en family wey get diziz, offa food ofrin to God.
LEV 21:18 Make nobody wey get diziz go offa food ofrin: dat is, doz wey blind, cripple, wey get sore or wey en body nor komplete;
LEV 21:19 man wey en hand and leg break;
LEV 21:20 man wey get hunch-back or man wey bi dwarf; man wey get diziz for eye or for en body and man wey nor gri marry.
LEV 21:21 Make nobody from Aaron family wey get diziz go offa food ofrin to God.
LEV 21:22 Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,
LEV 21:23 but e nor go enter di holy curtain or kom near di altar, bikos e get diziz. So e nor go offa dis tins, bikos na mi bi God and I don make dem dey holy.’ ”
LEV 21:24 So dis na wetin Moses tell Aaron, en sons and all di pipol for Israel.
LEV 22:1 God tell Moses:
LEV 22:2 “Make yu tell Aaron and en sons sey make dem nor disgrace my name wey dey holy, but make dem trit di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi with respet. Na mi bi God.
LEV 22:3 Make yu tell dem sey, ‘If una pikin wey nor klean go near di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi, den una go remove am from my pipol. Dis na wetin dem go do forever. Na mi bi God.
LEV 22:4 Nobody from Aaron family wey get diziz or dey discharge go chop di holy ofrin until e don dey holy. Pesin wey tosh anytin wey nor klean, bikos di tin tosh pesin wey don die; man wey dey discharge;
LEV 22:5 man wey tosh animal or pesin wey nor dey klean;
LEV 22:6 go dey unklean till evening. E nor go fit chop anytin among di holy ofrin, escept e first go baf.
LEV 22:7 Wen di sun don go down, e go dey klean, den e fit chop di holy ofrin, bikos na-im food.
LEV 22:8 E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God.
LEV 22:9 All di priest must keep my law, so dat dem nor go sin kon die bikos dem disobey. Na mi bi God wey make una holy.
LEV 22:10 “ ‘Na only pesin wey kom from di priest family go chop from di holy ofrin; nobody go fit chop dem! Pipol wey dey stay with am or anybody wey e hire to work for am nor go follow am chop.
LEV 22:11 But di priest slave wey e buy or wey dem born for en house go fit chop di food wey dem give di priest.
LEV 22:12 Di priest girl pikin wey marry who nor bi priest nor go chop for di holy ofrin,
LEV 22:13 but if di priest girl pikin husband don die or e don leave en husband and e nor born any pikin kon go back to en papa house, den e fit chop from e papa food, but no strenja go chop am.
LEV 22:14 If anybody chop ofrin wey dey holy and e nor know, e go add twenty percent join wetin e chop kon gi-am to di priest.
LEV 22:15 Dem must nor spoil di holy ofrin wey Israel pipol offa to God, but
LEV 22:16 if anybody wey nor suppose to chop am, chop am, e don bring wahala to ensef. Na mi bi God and I don make di ofrin holy.’ ”
LEV 22:17 God tell Moses:
LEV 22:18 “Make yu tell Aaron, en sons and Israel pipol sey, ‘Wen anybody from Israel pipol house or strenja dey give dia burnt ofrin; weda na to pay vow or na from dia mind,
LEV 22:19 If I go kollect am, den di animal wey dem go offa weda na kattle, sheep, or goat must dey okay.
LEV 22:20 Una must nor offa anytin wey nor dey okay, bikos I nor go asept am.
LEV 22:21 “ ‘If anybody won offa peace ofrin give God, weda na vow or na from en mind, di animal wey dem go use, must dey okay, so dat I go asept am.
LEV 22:22 Any animal wey blind, wey nor dey waka, get problem, sore or skin wey dey tear, make una nor offa am give God as ofrin.
LEV 22:23 Una fit offa animal wey short or wey neva mature as ofrin from una mind, but I nor go asept am if una use am take pay for una vow.
LEV 22:24 Make una nor give God any animal wey en private part get sore, kut, get mark or kut komot. Una must nor do dis tins for una land.
LEV 22:25 Make una nor offa any animal wey una get from strenja as food ofrin to God, bikos dat kind animal nor dey klean and I nor go asept dem.’ ”
LEV 22:26 God tell Moses:
LEV 22:27 “Wen dem just born lamp, melu or goat, e go dey under en mama for seven days, but for di eight day go, dem fit use am as gift ofrin to God and I go asept am.
LEV 22:28 Una nor go kill melu or sheep and en small pikin togeda for di same day.
LEV 22:29 Wen una dey offa tanksgivin sakrifice to God, una must follow di rule, so dat I go asept am from una.
LEV 22:30 Make una chop am for dat same day and no one must remain till di next morning.
LEV 22:31 Make una try to do all my kommandment. Na mi bi Oga God.
LEV 22:32 Make una nor disgrace my holy name, bikos I go show as I dey holy among Israel pipol. Na mi bi God wey make una dey holy
LEV 22:33 and na mi karry una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi Oga God.”
LEV 23:1 God tell Moses:
LEV 23:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na di day wey God choose for di festival and una go dey do am wen evribody gada to woship.
LEV 23:3 “ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.
LEV 23:4 “ ‘Make una do all dis festival for di time wen God tok.
LEV 23:5 For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God.
LEV 23:6 Di Fifteent day for di mont go bi di bread wey nor get yist feast and una nor go chop bread wey dem make with yist for eleven days.
LEV 23:7 For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.
LEV 23:8 Una must offa gift to God for seven days and for di sevent day, una go gada again kon woship God, but una nor go do any work.’ ”
LEV 23:9 God tell Moses:
LEV 23:10 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest.
LEV 23:11 E go offa am as special ofrin to God, so dat I go asept am. Na di day afta Sabat Day, di priest go offa am.
LEV 23:12 For di day wey una go offa di korn ofrin, una go sakrifice man lamb wey dey okay as burnt ofrin to God.
LEV 23:13 With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.
LEV 23:14 Make una nor chop any new korn, weda raw one or di one wey dem roast or bake to bread, until una don bring di ofrin kom meet God. Una shidren wey una go born go obey dis law forever and ever.
LEV 23:15 “ ‘Una must kount seven weeks from di day afta di Sabat Day, wen una bring di first korn wey una harvest kom give God.
LEV 23:16 Una must kount fifty days until di day afta seven Sabat Day don pass, den una go give God anoda new korn ofrin.
LEV 23:17 Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.
LEV 23:18 Una must offa seven lamb wey bi one year, one small melu and two rams, join di bread. Dem go bi burnt ofrin to God with dia korn and drink ofrin and God like dis gift.
LEV 23:19 Una go offa man goat for sin ofrin and lamb wey bi two years for peace ofrin.
LEV 23:20 Di priest go offa di bread and di two lamb as special gift to God. Dis ofrin dem dey holy.
LEV 23:21 For dat day, una nor go do una evriday work, but una go gada togeda woship mi. Una shidren go dey obey dis law forever.
LEV 23:22 Wen una gada di harvest from una land, make una nor harvest evritin for di land finish and una must nor gada evritin for una harvest. Make una leave some for poor pipol and strenjas. Na mi bi di Oga una God.’ ”
LEV 23:23 God tell Moses:
LEV 23:24 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di first day for di sevent mont, una go rest well-well and una must kom togeda kon woship mi wen una hear di trumpet sound.
LEV 23:25 Make una nor do any work, but una must give special ofrin to God.’ ”
LEV 23:26 God tell Moses:
LEV 23:27 “Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God.
LEV 23:28 Una nor go do any work for dat day, bikos na di day to pray make di Oga una God forgive una.
LEV 23:29 Anybody wey chop anytin for dat day, nor go dey among God pipol again.
LEV 23:30 And if anybody do any work for dat day, God go use en own hand kill-am.
LEV 23:31 Dis na di law wey all una pikin must obey, no matter where dem dey.
LEV 23:32 Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”
LEV 23:33 God tell Moses:
LEV 23:34 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di Fifteent day for di sevent mont, dem must use seven days take do di house feast for God.
LEV 23:35 Di first day na to woship am; den una nor go do any work.
LEV 23:36 For seven days, una must offa gift to God. For di eight day, una go gada woship kon give ofrin to God. Na di day for woship and una nor go do any work.
LEV 23:37 (Dis na di holy festival wey una go use take honor God as una gada dey woship and give ofrin to am. Dis ofrin na burnt and korn ofrin; sakrifice and drink ofrin for each day akordin to wetin God tok.
LEV 23:38 Dis festival join di normal Sabat Day and dis ofrin dem join di normal gift ofrin. Dis na ofrin to take do una vow and di ones wey una give God from una mind.)
LEV 23:39 “ ‘Wen una don harvest wetin una plant for una land, make una celebrate dis festival for seven days and e go start for di Fifteent day for di sevent mont. Di first day go dey special, so una go rest.
LEV 23:40 For dat day, una go take some of di good fruit from una tree, palm tree branches wey get leaf well-well kon celebrate to honor God.
LEV 23:41 Una must celebrate for seven days. Una shidren-shidren must keep dis law forever.
LEV 23:42 Make una stay for anoda place for seven days; all of una wey kom from Israel must stay der,
LEV 23:43 so dat una shidren-shidren go know sey na mi give una house afta I take una komot from Egypt. Na mi bi di Oga una God.’ ”
LEV 23:44 So Moses tell Israel pipol evritin wey God tok.
LEV 24:1 God tell Moses:
LEV 24:2 “Make yu kommand Israel pipol make dem bring pure olive oil wey fine well-well kom put for di lamp wey dey di tent, so dat lite go dey di temple.
LEV 24:3 For evening, Aaron go lite am till morning for God present outside di curtain for di Kovenant Box front wey dey for di holy place. Dis law go dey forever.
LEV 24:4 Aaron go kare for di lamp wey dey di lampstand and e go always dey arrange am for God present.
LEV 24:5 “Una must take twelf kilogram of flower kon bake twelf bread,
LEV 24:6 una go put di bread for two row, six-six for one row on-top di tabol wey dem kover with gold, wey dey God present.
LEV 24:7 Una must put pure incense for each row to dey remember di bread and e go bi gift ofrin to God.
LEV 24:8 For each Sabat Day, Aaron go always dey arrange am before God; dis na Israel pipol work forever.
LEV 24:9 Na Aaron and en sons get di bread and dem go chop am for di holy aria, bikos na holy food wey dem offa to God.”
LEV 24:10 E get one man, en papa kom from Egypt and en mama name na Shelomit wey Dibri from Dan tribe for Israel, born. For di kamp, di man kon dey kworel with one Israel man.
LEV 24:11 As dem dey fight, di Israel woman pikin kon curse God name, so dem take dem go meet Moses. (En mama name na Shelomit wey bi Dibri pikin from Dan tribe.)
LEV 24:12 Dem put am for prison dey wait for God to tell dem wetin dem go do.
LEV 24:13 Den God tell Moses:
LEV 24:14 “Make yu bring di man wey curse mi kom out from di kamp, anybody wey hear am dey curse go put dia hand for en head to bear witness against am sey e dey guilty and evribody for Israel go stone am till e die.
LEV 24:15 Make yu tell Israel pipol sey anybody wey curse God, go sofa di ponishment for en sin
LEV 24:16 and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die.
LEV 24:17 If pesin beat pesin die, dem must kill dat pesin too.
LEV 24:18 If pesin beat animal die, di pesin must give anoda animal to di pesin wey en animal don die, bikos di law sey, ‘Una go give life-for-life.’
LEV 24:19 If pesin wound en neighbour wey bi Israel pesin; just as e do am, na so dem go do am back!
LEV 24:20 If e break en neighbour bone, dem go break en bone too; if e blind pesin eye, dem go blind en own too; if e remove pesin tit, dem go remove en own too. Anytin wey pesin do en neighbour, dem go do am back.
LEV 24:21 Pesin wey kill any animal, go replace am. But pesin wey kill pesin, go die too.
LEV 24:22 Dis law na for all of una, weda yu bi Israel pesin or strenja. Na mi bi di Oga una God.”
LEV 24:23 Wen Moses don tell Israel pipol evritin finish, dem take di man go outside di kamp kon stone am die. Like dis, Israel pipol kon do as God kommand Moses.
LEV 25:1 God tell Moses for Mount Sinai:
LEV 25:2 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I dey give una, una must nor work for di sevent year, just as God kommand.
LEV 25:3 For six years, una go plant for una farm kon kut una gardin and gada wetin una harvest,
LEV 25:4 but for di sevent year, una must let di land rest kon dedikate dat year to God. Una must nor plant or harvest.
LEV 25:5 Make una nor even harvest any korn wey grow on dia own wey nobody plant and make una nor gada di grape from di gardin wey una nor kut; bikos na di year wey di land dey rest.
LEV 25:6 Even doh una nor plant for una land dat year, di land go produce food for una, una slave, di men wey una hire to work for una, di strenjas wey dey stay for una land,
LEV 25:7 una animals; di big animal wey dey una farm and all di tins wey di land produce, go bi food for una to chop.
LEV 25:8 “ ‘Make una kount seven times seven years and e go bi forty-nine years.
LEV 25:9 Den for di tent day for di sevent mont, di day to forgive sins, yu go send somebody go blow di trumpet for di whole land for Israel.
LEV 25:10 Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.
LEV 25:11 Una nor go plant for una farm or harvest di korn wey dey grow by ensef or gada di grape wey dey di land wey una nor kut.
LEV 25:12 Di whole year go dey holy to una; una go chop only di food wey di land produce by ensef.
LEV 25:13 “ ‘For dis year, all di land wey dem don sell, dem go gi-am back to dia owner.
LEV 25:14 Wen una sell land to una fellow Israel pipol or buy from dem, make una nor do wayo.
LEV 25:15 Una go fix di prize akordin to di nomba for di year wey di land go produce food, before di year wey una go riton am.
LEV 25:16 If di years many well-well, di prize go inkrease, but if di years small, di prize go low, bikos dem dey sell di food wey di land produce.
LEV 25:17 Make una nor play una fellow Israel pesin wayo, but make una obey di Oga una God.
LEV 25:18 “ ‘Una must obey my law and my kommandment, so dat una nor go fear for di land.
LEV 25:19 Di land go produce food and una go chop until una beleful and una nor go fear for di land.
LEV 25:20 If una sey, “Wetin wi go chop for di sevent year if wi nor plant or gada awa harvest?”
LEV 25:21 I go kommand my blessing for una for di sixt year, so dat di land go produce food wey una go chop for three years.
LEV 25:22 Even wen una plant for una farm for di eight year, una go still dey chop wetin una harvest for di sixt year and una go get plenty food to chop. Even wen una harvest for di ninet year, di ones wey una harvest for di sixt year, go still remain.
LEV 25:23 “ ‘Una nor go sell una land forever, bikos di land na God own and una bi strenja wey God allow to use di land.
LEV 25:24 Wen dem sell di land, una go sell back to di owner wen e won buy am back.
LEV 25:25 If any Israel pesin dey poor and una kon force am sell en land, e relashon wey dey klose to am go must buy am back.
LEV 25:26 If pesin nor get money to buy di land back den, but leta e kon get,
LEV 25:27 e go pay di man wey buy di land di money wey go rish to kover di remainin years, before di year wey dem go riton di land.
LEV 25:28 But if di pesin nor get plenty money to buy di land back, di land go dey with di man wey buy am till di year wey dem go riton di land. For dat year, e go riton di land give di owner.
LEV 25:29 “ ‘If anybody sell house for town wey get wall, e get di rite to buy am back for di first year wey e sell am.
LEV 25:30 But if e nor buy am back for dat year, e nor go fit buy am back again and di house go bi di pesin and en sons own; dem nor go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
LEV 25:31 But house wey dey for di village wey nor get wall, dem go trit dem like field; di first owner for di house get di rite to buy di house back and dem go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
LEV 25:32 Levi pipol get di rite to buy dia propaty back anytime for di town wey dem share give dem.
LEV 25:33 If Levi pesin sell one among di house for di town and dem nor buy am back, dem must riton am for di year wey dem dey riton propaty, bikos di house wey Levi pipol get for dia town, na dia permanent propaty among Israel pipol.
LEV 25:34 But di land wey dia animal dey stay, dem nor go sell am at-all; bikos na dia propaty e bi forever.
LEV 25:35 “ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una.
LEV 25:36 Make una nor add intrest join, but make una obey God, so dat una fellow Israel pipol go fit stay near una.
LEV 25:37 Make una nor add intrest for di money wey una borrow dem or gain for di food wey una sell give dem.
LEV 25:38 Na mi bi di Oga una God wey karry una komot from Egypt kon give una Kanaan land. Na mi bi una God.
LEV 25:39 “ ‘If una fellow Israel pipol wey dey stay near una dey poor kon sell ensef for una to bi slave, una nor go make am do di work wey oda slaves dey do.
LEV 25:40 E go stay with una as slave wey una hire and e go serve una until di year wey dem dey riton propaty.
LEV 25:41 For dat time, en and en sons go leave una kon go back to dia family and to dia propaty wey dia grand-grand papa get.
LEV 25:42 Israel pipol na God savants and E karry dem komot from Egypt; so una must nor sell dem as slave.
LEV 25:43 Make una nor trit dem anyhow, but make una obey di Oga wey bi una God.
LEV 25:44 But for una own slaves, una fit buy dem from di kountry wey dey near una.
LEV 25:45 Una fit still buy from di pikin wey di strenjas among una born. Doz pikin wey dem born for una land go fit bi una propaty.
LEV 25:46 Una fit give dem to una sons and dem go serve una shidren-shidren forever. But make una nor trit any Israel pesin anyhow.
LEV 25:47 “ ‘If di strenja wey dey stay with una kon get money and en fellow Israel pesin dey poor and e sell ensef give dat strenja to bi slave or anybody from en family,
LEV 25:48 afta dem don sell am, e still get di rite to buy ensef back. One pesin among en brodas fit buy am back,
LEV 25:49 or en uncle, kousin or family memba; or if en ensef get plenty money, e fit buy ensef back.
LEV 25:50 E go meet di pesin wey buy am and dem go kount di year wey e take sell ensef until di year wey dem dey riton propaty, den dem must tok di prize for am to dey free. Dis prize na as dem take dey pay di savant wey dem hire to work.
LEV 25:51 If many years still remain wey e go stay with dem, e go riton part of di money wey dem take buy am, so dat e go dey free.
LEV 25:52 But if di year wey remain dey small before di year wey dem go riton propaty, e go kakulate di money wey remain and e go pay am, so dat e go dey free.
LEV 25:53 If dem hire am for evry year, en oga nor go trit am anyhow.
LEV 25:54 If dem nor let am go like dat, en and en sons go dey free for di year wey dem dey riton propaty,
LEV 25:55 bikos Israel pesin nor fit bi slave forever, bikos dem bi my savant wey I karry komot from Egypt; Na mi bi di Oga wey bi dia God.’ ”
LEV 26:1 God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.
LEV 26:2 Una must keep di Sabat Day and honor di place where dem for dey woship mi. Na mi bi Oga God.
LEV 26:3 “If una keep my law and obey my kommand,
LEV 26:4 I go send una rain for di korrect time, so dat una land go produce food and una trees go bear fruits.
LEV 26:5 Una harvest go plenty well-well, sotey una go still dey harvest korn until di time to pick grape and una go still dey pick grape for di time to plant korn. Una go get all wetin una won chop and una nor go fear for di land wey una dey stay.
LEV 26:6 I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.
LEV 26:7 Una go ovakom una enemies.
LEV 26:8 Five of una go fit win hundred pipol and hundred of una go win 10,000 pipol.
LEV 26:9 I go bless and give una many shidren; I go keep my own part for di kovenant wey I make with una.
LEV 26:10 Una harvest go remain enter anoda year and una go even trowey wetin remain for di old harvest, so dat una go get space to put di new ones.
LEV 26:11 I go stay with una for inside my holy tent and I nor go ever komot for where una dey.
LEV 26:12 I go dey with una; I go bi una God and una go bi my pipol.
LEV 26:13 Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, so dat una nor go bi slave again. I skata di pawa wey hold una for groun and I make una waka with pride.”
LEV 26:14 God kon tell dem, “If una nor obey my kommand, I go ponish una.
LEV 26:15 If una nor gri obey my law, kommand or keep di kovenant wey I make with una,
LEV 26:16 I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
LEV 26:17 I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
LEV 26:18 “If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times.
LEV 26:19 I go break una strong pride; una nor go get rain; una land go dry kon strong like iron.
LEV 26:20 All una hard work nor go do una good, bikos una land nor go produce food and di trees nor go bear fruit.
LEV 26:21 “If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.
LEV 26:22 I go send wild animals among una and dem go kill una shidren; distroy una animal kon kill una pipol and di road go dey dry.
LEV 26:23 “If afta all dis ponishment una still nor listin to mi, but kontinue to rijet mi,
LEV 26:24 I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before.
LEV 26:25 I go ponish una with war, bikos una nor keep di kovenant wey I make with una and if una gada for una towns make una for dey save, I go send diziz wey dem nor dey fit cure among una and una enemies go win una.
LEV 26:26 Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.
LEV 26:27 “If afta all dis tins happen, una still dey rijet or disobey mi,
LEV 26:28 I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.
LEV 26:29 Una go dey hongry sotey una go dey chop una own shidren.
LEV 26:30 I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
LEV 26:31 I go distroy una towns kon skata di place where una for dey woship and I nor go asept una sakrifice.
LEV 26:32 I go distroy una land finish and una enemies wey dey stay der before, go shok for di kind distroshon.
LEV 26:33 I go make war happen to una and I go skata una go strenj land. Nobody go dey di land and I go distroy una towns.
LEV 26:34 Den di years for komplete rest wey una nor gri give di land, go kon happen;
LEV 26:35 nobody go dey der and e go kon get en rest wen una enemies don karry una go dia land.
LEV 26:36 “I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
LEV 26:37 Una go dey shake as if pesin dey porshu una and una nor go fit fight with una enemies.
LEV 26:38 Una go die for una enemies land and di land go swallow una.
LEV 26:39 “Doz of una wey nor go die for una enemy land go waste trowey, bikos of una and una grand-grand papa sin.
LEV 26:40 Una shidren-shidren go konfess both dia sin and dia grand-grand papa own, wey rijet and dey sturbon to mi,
LEV 26:41 kon make mi turn against and give dem as slave to dia enemies. But wen una shidren-shidren honbol demsef and dem pay for dia sins and sturbones,
LEV 26:42 I go remember di kovenant wey I make with Abraham, Isaak and Jakob kon fulfil my promise, den give my pipol di land.
LEV 26:43 All di pipol wey dey di land must komot first, make e for get komplete rest and dem must pay di prize, bikos dem rijet my law and kommand.
LEV 26:44 “But even wen dem still dey dia enemy land, I nor go leave and distroy dem finish. Bikos dat one go make my kovenant with dem end, na mi bi di Oga dia God.
LEV 26:45 I go renew di kovenant wey I make with dia papa wen I show all di kountries my pawa wey I take karry dem komot from Egypt, so dat mi wey bi di Oga God, go bi dia God.”
LEV 26:46 All dis na di law and kommand wey God give Moses for Mount Sinai about Israel pipol.
LEV 27:1 God tell Moses:
LEV 27:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen man don give ensef to God to take fulfil di special vow wey e make, di pesin go dey free afta e don pay dis money,
LEV 27:3 bikos man wey bi from twenty years go rish sixty years, na fifty shekel e go pay akordin to di shekel wey dem dey take for di temple.
LEV 27:4 If di pesin na woman, na thirty shekel e go pay.
LEV 27:5 If di pesin na from five years go rish twenty years; for man, na twenty shekel and for woman, na ten shekel e go pay.
LEV 27:6 If di pesin na from one mont go rish five years; for man, na five shekel and for woman; na three shekel e go pay.
LEV 27:7 If di pesin na from sixty years go up, if na man, na fifteen shekel and woman, na ten shekel e go pay.
LEV 27:8 If e nor get money take pay en vow, e must take di pesin to di priest and di priest go reduce di money, akordin to wetin di pesin go fit pay.
LEV 27:9 “ ‘If na animal e vow sey e go give God as ofrin, den anytin wey e give to God from dis animal go dey holy.
LEV 27:10 And anybody wey make dis vow, nor go use anoda animal take replace am, weda na good for bad or bad for good. If e go use anoda animal, den di normal one and di ones wey e shange am to, go dey holy.
LEV 27:11 If wetin e vow na animal wey nor klean; wey e nor go fit give as ofrin to God, den e go make di animal stand before di priest,
LEV 27:12 di priest go kon fix prize for am, weda e good or bad and na di prize wey di priest tok, go bi di final prize.
LEV 27:13 If di pesin won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
LEV 27:14 “ ‘Wen pesin dedikate en house to God, di priest go fix di prize weda e good or bad and di prize go bi di final prize.
LEV 27:15 If di pesin wey dedikate di house won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
LEV 27:16 “ ‘If anybody dedikate one part of en field to God, di priest go fix di prize akordin to di nomba of seed wey dem go fit plant and e go bi ten silva for evry twenty kilogram for barley.
LEV 27:17 If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize.
LEV 27:18 If e dedikate am leta, di priest go kakulate di money akordin to di years wey remain before di next Sabat year, den e go reduce di prize.
LEV 27:19 If di pesin wey dedikate di field won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
LEV 27:20 If dem sell di field give anoda pesin, e nor go fit buy am back.
LEV 27:21 For di year wey dem dey free pipol, di field go kon bi God own forever; so e go kon bi di priest own.
LEV 27:22 If anybody dedikate field wey dem buy give God,
LEV 27:23 di priest go kakulate di money akordin to di nomba of years wey remain before di next Sabat year and di pesin must pay di money for dat same day; na God get di money.
LEV 27:24 Dem go give di field back to di pesin wey really get am or en shidren-shidren for di year wen dem dey free pipol.
LEV 27:25 Di priest go fix all di prize, just as dem tok for di sanctuary.
LEV 27:26 “ ‘Di first pikin for evry animal na God own, so make anybody nor dedikate am to God as ofrin from en mind. Weda na melu or kattle, na God get am.
LEV 27:27 But animal wey nor klean, dem go fit buy en first pikin back for di normal prize kon add twenty percent join. If e nor buy am back, dem go sell am give anoda pesin for di normal prize.
LEV 27:28 “ ‘Make anybody nor sell or buy wetin dem don dedikate give God without kondishon. Weda na human being, animal or land, bikos na God own forever.
LEV 27:29 Even if na human being, if dem dedikate am without any kondishon, dem nor go fit buy am back; dem must kill-am.
LEV 27:30 “ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own.
LEV 27:31 If anybody one buy am back, e must pay di normal prize kon add twenty percent join.
LEV 27:32 One out of evry ten animal wey dey stay house, go bi God own. Wen dem don kount di animals finish, di tent one go bi God own.
LEV 27:33 Di owner nor go arrange di animals, so dat dem go fit choose di bad one and make e nor shange any one wey dem choose. If e shange any animal for anoda one, den di two animal go bi God own and e nor go fit buy dem back.’ ”
LEV 27:34 Dis na di kommand wey God give Moses for Mount Sinai and na for Israel pipol.
NUM 1:1 God kon tell Moses for di place where dem for dey do meetin for Sinai Wildaness, for di first day, for di sekond mont for di sekond year, afta dem don komot from Egypt:
NUM 1:2 “Make yu kount Israel pipol akordin to dia family and tribes, den yu go rite all di men names.
NUM 1:3 Make yu and Aaron go nomba all di men for Israel wey bi from twenty years or old pass like dat wey go fit fight war.
NUM 1:4 Make una take one man from each tribe and e must bi oga for en family, so dat dem go help una.
NUM 1:5 Naw, di men wey go help una, na dia names bi dis: from Reuben tribe, Elizur wey Shedeur born; from Simeon tribe, Shelumiel wey bi Zurishaddai pikin; from Judah tribe, Nahshon wey bi Amminadab pikin; from Issakar tribe, Netanel wey Zuar born; from Zebulun tribe, Eliab wey bi Helon pikin; from Josef sons: from Efraim tribe, Elishama wey bi Ammihud pikin and from Manasseh tribe, dem pick Gamaliel wey Pedahzur bi en papa; from Benjamin tribe, Abidan wey Gideoni born; from Dan tribe, Ahiezer wey Ammishaddai born; from Asher tribe, Pagiel wey Okran bi en papa; from Gad tribe, Eliasaf wey Deuel born and from Naftali tribe, dem pick Ahira wey bi Enan pikin.”
NUM 1:16 Na dis ones dem choose from di kommunity, as leaders from dia grand-grand papa tribe. Na dem bi oga for all di pipol wey dey Israel.
NUM 1:17 So Moses and Aaron take all di men wey dem koll dia name
NUM 1:18 kon gada all di pipol for di first day for di sekond mont. Den dem register di pipol akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so. Dem kount all of dem by names,
NUM 1:19 just as God kommand Moses and na so e take nomba dem for Sinai Wildaness.
NUM 1:20 And dem bi: Israel first pikin Reuben akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia name. Di nomba for Reuben tribe na 46,500. From Simeon tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Simeon tribe na 59,300. From Gad tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Gad tribe na 45,650. From Judah tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Judah tribe na 74,600. From Issakar tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Issakar tribe na 54,400. From Zebulun tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Zebulun tribe na 57,400.
NUM 1:32 From Josef sons: From Efraim tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Efraim tribe na 40,500. From Manasseh tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Manasseh tribe na 32,200. From Benjamin tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Benjamin tribe na 35,400. From Dan tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Dan tribe na 62,700. From Asher tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Asher tribe na 41,500. From Naftali tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Naftali tribe na 53,400.
NUM 1:44 Dis na di men wey Moses and Aaron kount plus di twelf leaders wey dey Israel, each of dem kom from dia own family.
NUM 1:45 All di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so for Israel wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names akordin to dia tribe and family,
NUM 1:46 na 603,550.
NUM 1:47 But dem nor kount Levi pipol join di oda tribes,
NUM 1:48 bikos God tell Moses sey,
NUM 1:49 “Make yu nor kount Levi tribe join di oda tribes for Israel.
NUM 1:50 But make yu put Levi pipol to look, kare and dey near di Tabanako and evritin wey dey inside.
NUM 1:51 Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.
NUM 1:52 So make Israel pipol kamp akordin to di way dem divide dem and each man go dey en own group akordin to en family name.
NUM 1:53 But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”
NUM 1:54 Israel pipol do all di tins wey God kommand dem thru Moses.
NUM 2:1 God kon tell Moses and Aaron:
NUM 2:2 “Evribody for Israel must stay with en family; dem must stay near di tent where dem for dey do meetin.”
NUM 2:3 Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.
NUM 2:4 Di pipol wey dem kount for dis group na 74,600.
NUM 2:5 Doz wey stay klose to dem na Issakar tribe. Di pesin wey dey lead Issakar pipol, na Netanel wey Zuar bi en papa.
NUM 2:6 Di pipol wey dem kount for dis group na 54,400.
NUM 2:7 Di oda one na Zebulun tribe. Di pesin wey dey lead Zebulun pipol na Eliab wey bi Helon pikin.
NUM 2:8 Di pipol wey dem kount for dis group na 57,400.
NUM 2:9 All di pipol wey dem kount for Judah wey stay akordin to dia group, na 186,400. Na dem go travel for front.
NUM 2:10 For di sout, doz pipol wey dey under Reuben tribe, stay akordin to dia group and di pesin wey dey lead Reuben pipol, na Elizur wey en papa na Shedeur.
NUM 2:11 Di pipol wey dey under Reuben tribe na 46,500.
NUM 2:12 Di pipol wey go stay near dem, na Simeon tribe. Di pesin wey dey lead Simeon pipol na Shelumiel wey Zurishaddai born.
NUM 2:13 Di pipol wey dey under Simeon tribe na 59,300.
NUM 2:14 Di next pipol na Gad tribe. Di pesin wey dey lead dem na Eliasaf wey bi Deuel pikin.
NUM 2:15 Di pipol wey dey under Gad tribe na 45,650.
NUM 2:16 All di pipol wey dey Reuben kamp akordin to dia group na 151,450. Na dem bi di sekond group to travel.
NUM 2:17 Between di first group and di sekond group, na Levi pipol go waka for dia centre and dem go karry di tent. Dem go travel just as dem kamp, evry group akordin to en own place under en family name.
NUM 2:18 Di group for west na Efraim tribe. Di pesin wey dey lead dem na Elishama wey Ammihud born.
NUM 2:19 Di pipol wey dey under Efraim tribe na 40,500.
NUM 2:20 Di pipol wey go stay near dem na Manasseh tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Gamaliel wey Pedahzur bi en papa.
NUM 2:21 Di pipol wey dey under Manasseh tribe na 32,200.
NUM 2:22 Di pipol wey go stay near dem na Benjamin tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Abidan wey Gideoni born.
NUM 2:23 Di pipol wey dey under Benjamin tribe na 35,400.
NUM 2:24 All di pipol wey dey Efraim tribe akordin to dia group, na 108,100. Na dem go bi di third group to travel.
NUM 2:25 Di group for nort na Dan tribe. Di pesin wey dey lead di group na Ahiezer wey Ammishaddai born.
NUM 2:26 Di pipol wey dey under Dan tribe na 62,700.
NUM 2:27 Di pipol wey go stay near dem na Asher tribe. Di pesin wey dey lead di group na Pagiel wey bi Okran pikin.
NUM 2:28 Di pipol wey dey under Asher tribe na 41,500.
NUM 2:29 Di pipol wey go stay near dem na Naftali tribe. Di pesin wey dey lead di group na Enan pikin, Ahira.
NUM 2:30 Di pipol wey dey under Naftali tribe na 53,400.
NUM 2:31 All di pipol wey dey Dan kamp, na 157,600. Na dem go travel last, just as dem arrange am.
NUM 2:32 Israel pipol wey dem kount akordin to dia group na 603,550.
NUM 2:33 But dem nor kount Levi pipol join, bikos God don kommand Moses sey na so e go bi.
NUM 2:34 So Israel pipol do all wetin God tell Moses; na so dem kamp under dia family name kon travel; each pesin with en tribe and family.
NUM 3:1 Dis na both Aaron and Moses family afta God tok with Moses for Mount Sinai.
NUM 3:2 Dis na Aaron sons name; di first pikin na Nadab, den Abihu, before Eleazar and den Itama.
NUM 3:3 Aaron wey dem choose as priest to serve God, dis na di sons wey e born kon make dem priests.
NUM 3:4 Nadab and Abihu die for God present wen dem give wetin nor dey klean to God for Sinai Wildaness and dem nor get shidren. So Eleazar and Itama kon dey work as priest for where Aaron wey bi dia papa dey.
NUM 3:5 God tell Moses:
NUM 3:6 “Make yu bring Levi pipol and make dem bi savant to Aaron wey bi di priest.
NUM 3:7 Dem go dey do di work wey dem suppose do for di tent, for di priest and for all di pipol.
NUM 3:8 Dem go kare for evritin wey dey inside di tent and for Israel pipol.
NUM 3:9 Di only work wey Levi pipol get to do, na to serve Aaron and en sons.
NUM 3:10 So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”
NUM 3:11 Den God tell Moses:
NUM 3:12 “Si, I don use Levi pipol take replace all di first-born for Israel. So na mi get Levi pipol,
NUM 3:13 bikos all di first-born na my own. Wen I kill all di first-born for Egypt, I keep all di first pikin for Israel for mysef, so both man and animal na my own. Na mi bi Oga God.”
NUM 3:14 Den Oga God tell Moses for Sinai Wildaness sey:
NUM 3:15 “Make yu kount Levi pipol akordin to dia town and family. Evry boy pikin from one mont go, naim yu go kount.”
NUM 3:16 So Moses kount dem just as God kommand am.
NUM 3:17 Dis na Levi sons akordin to dia names: Gershon, Kohat and Merari.
NUM 3:18 Dis na Gershon sons name akordin to dia family: Libni and Shimei.
NUM 3:19 Kohat sons akordin to dia family na: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
NUM 3:20 Merari sons akordin to dia family na: Mahli and Mushi. All dis na Levi pipol akordin to dia family.
NUM 3:21 Na Gershon born Libni and Shimei pipol and na dem bi Gershon family.
NUM 3:22 Doz wey dem kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 7,500.
NUM 3:23 Gershon family go stay for di west side wey dey di Tabanako back yard.
NUM 3:24 Di pesin wey dey lead Gershon pipol, na Eliasaf wey bi Lael pikin.
NUM 3:25 Di work wey Gershon pipol go do for di tent na to kare for di Tabanako, di tent kover; both for inside and outside, di curtain wey dey di tent gate where dem for dey do meetin,
NUM 3:26 di curtains for di kourtyard, di curtain for di kourtyard front for di Tabanako and di altar with di ropes and evry oda tin wey dem dey use for der.
NUM 3:27 Na Kohat born Amram, Izhar, Hebron and Uzziel family.
NUM 3:28 Doz wey dem don kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 8,600.
NUM 3:29 Na dem go kare for di Holy Place. Kohat family go stay near di sout-side for di Tabanako.
NUM 3:30 Di pesin wey dey lead dem na Elizafan wey Uzziel born.
NUM 3:31 Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.
NUM 3:32 Naw, di pesin wey dey lead all di leaders for Levi tribe, na Eleazar wey Priest Aaron born. So dem choose am to supavise doz wey dey work for di Holy Place.
NUM 3:33 Na Merari born Mahli and Mushi family.
NUM 3:34 Doz wey dem don kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 6,200.
NUM 3:35 Di pesin wey dey lead dem na Zuriel wey Abihail born. Dis pipol go stay near di nort side for di Tabanako.
NUM 3:36 Di work wey dem give Merari pipol join di frame for di Tabanako, na to kare for di cross bar, post, socket, tools and all di work wey dem dey do with dis tins.
NUM 3:37 Di pilas for di kourt wey round am with dia socket, dia peg and dia ropes.
NUM 3:38 But di pipol wey go stay for di Tabanako front for east wey face di tent where dem for dey do meetin, na Moses, Aaron and en sons. Na dem go kare for di tins wey dem nid for di Holy Place and wetin Israel pipol wont. But if anybody wey nor suppose go der, go der, dem go kill-am.
NUM 3:39 All di pipol wey Moses and Aaron kount wey kom from Levi akordin to dia family and di word wey God tok, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 22,000 dem bi.
NUM 3:40 Den God tell Moses, “Make yu kount all di first sons for Israel, from one mont go kon know dia names.
NUM 3:41 But Levi pipol must keep all dia first-born wey bi man for mi! Na mi bi Oga God! Na mi get all di first pikin wey Levi pipol animal go born. So I go take Levi first sons and animals as my own kon leave di rest tribes.”
NUM 3:42 So Moses kount all di first sons for Israel, just as God kommand am.
NUM 3:43 And evry first son wey dem kount from one mont go na 22,273.
NUM 3:44 Den God tell Moses:
NUM 3:45 “Make yu take Levi pipol instead of all di first-born for Israel, den all di first-born wey Levi pipol animal go born, make yu give dem to mi, instead of all di first-born wey di whole Israel animal go born. Levi pipol go bi my own. Na mi bi Oga God.
NUM 3:46 Israel pipol first sons use 273 take plenty pass Levi pipol own, so yu must buy di remainin shidren back.
NUM 3:47 For each one, yu go pay five pieces for silva, akordin to di money wey dem dey kollect for di Holy Place.
NUM 3:48 And una go give dis money to Aaron and en sons.”
NUM 3:49 So Moses kollect silva kon buy di first-born for Israel back wey many pass Levi own.
NUM 3:50 E kollect 1,365 pieces for silva to take buy di first-born for Israel (each of di money na as dem dey measure am with di sanctuary shekel).
NUM 3:51 Den e take di money go give Aaron and en sons, just as God kommand am.
NUM 4:1 God tell Moses and Aaron:
NUM 4:2 “Kohat pipol wey kom from Levi tribe, make dem kount dem akordin to dia family and towns.
NUM 4:3 Make dem kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 4:4 “Dis na di work wey Kohat pipol go do for di tent where dem for dey do meetin and koncerning di holy tins.
NUM 4:5 Wen time don rish for di pipol to travel, Aaron and en sons must enter di tent kon take di curtain take kover di Kovenant Box.
NUM 4:6 Den dem go use fine leda take kover am kon spread blue klot on-top. Den, dem must put di poles wey dem go take karry am for inside.
NUM 4:7 “Make dem use blue klot kover di tabol wey God bread dey, di plate, di incense bowl, di ofrin bowl and di jar wey dem dey use for wine ofrin. Bread must always dey di tabol.
NUM 4:8 Dem must use red klot and fine leda take kover am, den put di poles wey dem go take karry am for inside.
NUM 4:9 “Di lampstand, di lamps, di fork, tray and all di olive oil kontaina wey dey der, dem go kover am with blue klot.
NUM 4:10 Make dem wrap am with di oda tools with fine leda kon put am for sometin wey dem go fit take karry am.
NUM 4:11 “Dem go spread blue klot for di altar wey dem make with gold kon kover am with fine leda and di poles wey dem go take karry am, go dey inside.
NUM 4:12 Dem go take all di tools wey dem dey use for di Holy Place, wrap dem with blue klot; use fine leda take kover dem kon put dem for sometin wey dem go fit take karry dem.
NUM 4:13 “Dem go still remove di ashes wey dey di altar kon kover am with purpol klot.
NUM 4:14 Den all di tools wey dem dey use take work for di altar, dem go put am on-top: di tray, di hook, shovel and basin. Den dem go kover am with fine leda kon put di poles wey dem go take karry am for inside.
NUM 4:15 Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
NUM 4:16 “Di work wey dem give Aaron son, Eleazar, na di whole tent and di oil wey dey di lamps, di incense, di korn ofrin, di anointin oil and evry oda tin wey dey di tent wey dem don make holy for God.”
NUM 4:17 God tell Moses and Aaron,
NUM 4:18 “Make una nor allow God remove Kohat family from Levi tribe;
NUM 4:19 but dis na wetin una go do for dem, so dat dem nor go die wen dem go near di holy tins: Aaron and en sons go give each man en own work.
NUM 4:20 Kohat pipol nor go-go inside go look wen dem dey kover di holy tins, if not, dem go die.”
NUM 4:21 God kon tell Moses:
NUM 4:22 “Gershon pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns.
NUM 4:23 Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 4:24 Gershon pipol work na to karry dis tins wey bi:
NUM 4:25 di tent, di kover for inside and outside, di fine leda kover on-top am, di curtain for di door-mot,
NUM 4:26 di curtains and di ropes for di kourt wey round di tent and di altar; di curtains wey dey di kourt door-mot and all di tins wey dem use take arrange dem. So na dem go do dis work.
NUM 4:27 Moses and Aaron go make sure sey Gershon pipol do all di work and karry evritin wey Aaron and en sons suppose use.
NUM 4:28 Dis na di work wey Gershon pipol go do for di tent; dem go karry am komot, just as Aaron pikin, Itama, kommand dem.”
NUM 4:29 God tell Moses, “Merari pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns.
NUM 4:30 Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 4:31 Dia work go bi to karry di frame, bar, post and base for di tent.
NUM 4:32 Di oda post, base, peg and ropes for di kourt wey round di tent, with all di tins wey dem take make dem. Each man go karry di tins wey dem sey make e karry.
NUM 4:33 Dis na di work wey Merari pipol go do for di tent: dem go karry dem komot, just as Aaron tell dem.”
NUM 4:34 So Moses, Aaron and di leaders kon kount Kohat pipol akordin to dia family and towns,
NUM 4:35 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 4:36 Doz wey dem kount akordin to dia family na 2,750.
NUM 4:37 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Kohat family, evribody go work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
NUM 4:38 Doz wey dem kount for Gershon family, akordin to dia family and towns,
NUM 4:39 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 4:40 Doz wey dem kount akordin to dia family and towns na 2,630.
NUM 4:41 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Gershon family wey fit work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
NUM 4:42 Doz wey dem kount for Merari family, akordin to dia family and towns,
NUM 4:43 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin
NUM 4:44 na 3,200.
NUM 4:45 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Merari family, just as God kommand.
NUM 4:46 All di pipol for Levi tribe, wey Moses, Aaron and di leaders kount akordin to dia family and towns,
NUM 4:47 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin,
NUM 4:48 na 8,580.
NUM 4:49 Moses kount all dis pipol, just as God kommand am and each pesin get en work.
NUM 5:1 So God tell Moses:
NUM 5:2 “Go kommand Israel pipol sey, ‘Dis na di pipol wey una go remove from di kamp: pipol wey get diziz for skin, doz wey dey discharge and evribody wey nor dey klean, bikos e go tosh dead body.
NUM 5:3 Weda dem bi man or woman, una must porshu dem komot from di kamp, so dat dem nor go make di kamp unklean, bikos God dey stay der with en pipol.’ ”
NUM 5:4 So Israel pipol do wetin God tell dem kon drive dis pipol komot from di kamp.
NUM 5:5 So God tell Moses:
NUM 5:6 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen pesin nor dey fear God and e sin against en neighbour,
NUM 5:7 e must konfess and pay for evritin kon add twenty percent join for di pesin wey e sin against.
NUM 5:8 But if di pesin don die and e nor get broda or sista wey di oda pesin go pay give, e go gi-am to God priests. Dis money na with di ram wey dem go take do sakrifice to make di pesin wey sin, holy.
NUM 5:9 Israel pipol ofrins for dia holy tins, go bi di priest own.
NUM 5:10 Evry holy tin from human being go bi di priest own and anytin wey any man give di priest, go still bi di priest own.’ ”
NUM 5:11 God tell Moses:
NUM 5:12 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘If any man tink sey en wife nor dey faithful to am
NUM 5:13 sey di woman don dey unklean, bikos e go sleep with anoda man and nobody tok or katch am,
NUM 5:14 den if di husband kon dey jealous or jealousy spirit enter en body and e kon dey suspet en wife sey e dey unklean,
NUM 5:15 di man must take en wife to di priest and e must bring di ofrin wey woman nid to give wey bi: one from evry Efah barley wey dem divide into ten. E nor go pour olive oil on-top or put any incense, bikos di ofrin na for pesin wey yu suspet and yu won know di trut.
NUM 5:16 “ ‘Di priest go take di woman go stand for di altar front.
NUM 5:17 Den e go pour some holy wota for inside one bowl wey dem make with klay kon pak some san wey dey groun for di Tabanako put for di wota den e go bitter.
NUM 5:18 Den e go luz di woman hair kon put di korn ofrin for di woman hand. Di priest go hold di bowl wey di bitter wota wey dey bring curse dey.
NUM 5:19 Den di priest go make di woman swear sey: “If I nor really sleep with who nor bi my husband, di curse wey di wota dey bring, nor go do mi anytin.
NUM 5:20 But if I sleep with man wey nor bi my husband,
NUM 5:21 make God curse mi among di pipol. Make E nor give mi pikin again.
NUM 5:22 As dis wota enter my belle, I nor go fit born again.” Di woman go gri sey make God do am like dat.
NUM 5:23 Den di priest go rite dis curse for di book kon wosh dem for inside di bowl wey get bitter wota.
NUM 5:24 “ ‘Before e go make di woman drink di bitter wota wey go bring curse and pain to am,
NUM 5:25 di priest go take di korn ofrin komot from di woman hand, wave di korn ofrin before God kon take am go di altar.
NUM 5:26 Den di priest go take di korn ofrin wey go full en hand as small ofrin kon burn am for di altar. Afta dis, di woman go drink di bitter wota.
NUM 5:27 If di woman sleep with anoda man, di wota go gi-am betta pain; e nor go fit born again and na curse go follow am among di pipol.
NUM 5:28 But if di woman nor do am, den nor-tin go happen and e go fit born again.
NUM 5:29 “ ‘Dis na jealousy law, about wife wey still dey en husband house kon go sleep with anoda man
NUM 5:30 or wen di man suspet sey en wife dey sleep with anoda man; den di man must make sure sey di woman stand before God, while di priest go do di sakrifice.
NUM 5:31 Di husband go dey free from sin, but di woman go sofa for di sin wey e kommit.’ ”
NUM 6:1 Den God tell Moses:
NUM 6:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘If anybody make special vow to bi Nazirite, wey bi to give ensef to God,
NUM 6:3 e must nor drink wine, strong drink or vinegar wey dem make from wine or strong drink; e nor go drink any juice wey dem make with grape and make e nor chop any grape weda na fresh or dry one.
NUM 6:4 As far sey dem bi Nazirite, make dem nor chop anytin wey kom from grape farm, even if na grape seed or skin.
NUM 6:5 “ ‘As long sey dem don vow to bi Nazirite, dem must nor kut dia hair or shave am. Dem don bilong to God forever, so dem go dey holy and allow dia hair grow.
NUM 6:6 As long as dem don give diasef to God, dem must nor tosh dead body.
NUM 6:7 Dem must nor dirty demsef, bikos of dia papa, mama, broda or sista wey die, bikos na dia hair show sey dem dey holy for God eye.
NUM 6:8 As far sey dem bi Nazirite, dem must dey holy to God.
NUM 6:9 “ ‘If anybody just die near am and e kon make ensef unklean since e don give ensef to God, den e must shave en hair for di day wen dem dey klean am. E must shave am for di sevent day, so dat e go dey klean.
NUM 6:10 For di eight day, e go bring two dove or two pijin to di priest for di tent door-mot.
NUM 6:11 Di priest go offa one as sin ofrin and di oda as burnt ofrin, bikos e go near dead body, den afta di ofrin, e go dey klean. For dat same time, en hair go dey holy again
NUM 6:12 and e go give ensef back to God as Nazirite. Di time wey e make ensef unklean, nor mean anytin again. E go bring one year man lamb kom as ofrin to pay for en sin.
NUM 6:13 “ ‘Na Nazirite law bi dis: Wen pesin wey bi Nazirite don finish en vow, e go kon do dis sakrifice. E go-go di tent door-mot
NUM 6:14 kon give God three animals wey dey okay: lamb wey bi one year for burnt ofrin, iyu lamb wey bi one year for sin ofrin and one ram for fellowship ofrin.
NUM 6:15 Dem go still give one basket wey bread wey dem nor make with yist full: kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil and biscuit wey dem take olive oil rub plus di korn ofrin and di wine wey dem nid.
NUM 6:16 “ ‘Di priest go give all dis tins to God kon offa di sin and di burnt ofrin.
NUM 6:17 E go sakrifice di ram to God as fellowship ofrin kon offa am with di bread. Di priest go give en own korn and wine ofrin too.
NUM 6:18 For di tent door-mot, di Nazirite go shave en hair kon put am for fire for where dem for dey burn di fellowship ofrin.
NUM 6:19 “ ‘Den, wen dem don boil di ram shoulder, di priest go take am kon put am for di Nazirite hand with one kake and one biscuit from di basket.
NUM 6:20 Den, di priest go give dem as special gift to God; na holy ofrin for di priest, with di ram breast and leg, bikos na di priest own akordin to wetin dem rite for di law. Afta dis, di Nazirite go fit drink wine.’
NUM 6:21 Wen pesin vow to give ensef and any oda tin as ofrin to God, e go must do evritin wey e promise.”
NUM 6:22 God tell Moses:
NUM 6:23 “Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na how una go take bless Israel pipol. Make una tell dem:
NUM 6:24 “ ‘ “God go bless and protet una;
NUM 6:25 God go dey kind and good to una;
NUM 6:26 God go look una with favor kon give una peace.” ’
NUM 6:27 So my name go always dey Israel pipol mout and I go bless dem.”
NUM 7:1 Wen Moses don set di Tabanako finish, e kon anoint and dedikate di tent, di altar and evritin wey dey inside.
NUM 7:2 Den di leaders for Israel, di heads for di tribes kon give one ofrin. Na dis pipol bi leaders for di tribes and na dem dey monitor di kountin.
NUM 7:3 Di ofrin wey dem bring to God na: six truck and twelf melu. One truck na for two leader and one melu for each leader, so dem give dem to God for di Tabanako front.
NUM 7:4 Den God tell Moses:
NUM 7:5 “Make yu kollect dis tins from dem kon give dem to Levi pipol make dem take do dia difren-difren work.”
NUM 7:6 So Moses give di truck and di melu to Levi pipol.
NUM 7:7 E give two truck and four melu to Gershon pipol,
NUM 7:8 four truck and eight melu to Merari pipol and na Itama, Aaron pikin dey direct dem for dia work.
NUM 7:9 But Moses nor give Kohat pipol any truck or any melu, bikos na di holy tins wey dem karry for dia shoulder, bi dia work.
NUM 7:10 Di leaders bring gift to take dedikate di altar wen dem don anoint am kon drop dem der.
NUM 7:11 Bikos God tell Moses sey, “Dem must give dia ofrin to take dedikate di altar; one leader for each day.”
NUM 7:12 Di one wey give en ofrin for di first day na Nahshon wey Amminadab born and na from Judah tribe e from kom.
NUM 7:13 En ofrin na one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, but na akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:14 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:15 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:16 one man goat for klean ofrin
NUM 7:17 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Nahshon, wey Amminadab born, give.
NUM 7:18 For di sekond day, Netanel wey Zuar born, wey dey lead Issakar tribe kon give en ofrin.
NUM 7:19 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:20 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:21 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:22 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:23 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Netanel, wey Zuar born, give.
NUM 7:24 For di third day, Eliab wey Helon born, wey bi leader for Zebulun tribe kon give en ofrin.
NUM 7:25 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:26 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:27 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:28 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:29 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliab, wey Helon born, give.
NUM 7:30 For di fourt day, Elizur wey bi Shedeur pikin, di leader for Reuben tribe kon give en ofrin.
NUM 7:31 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:32 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:33 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:34 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:35 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elizur, wey Shedeur born, give.
NUM 7:36 For di fift day Shelumiel wey Zurishaddai born, wey dey lead Simeon tribe kon give en ofrin.
NUM 7:37 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:38 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
NUM 7:39 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:40 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:41 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Shelumiel, wey Zurishaddai born, give.
NUM 7:42 For di sixt day, Eliasaf wey Deuel born, wey dey lead Gad tribe kon give en ofrin.
NUM 7:43 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:44 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
NUM 7:45 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:46 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:47 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliasaf, wey Deuel born, give.
NUM 7:48 For di sevent day, Elishama wey Ammihud born, wey dey lead Efraim pipol, kon give en ofrin.
NUM 7:49 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:50 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:51 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:52 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:53 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elishama, wey Ammihud born, give.
NUM 7:54 For di eight day, Gamaliel wey Pedahzur born, wey dey lead Manasseh tribe, kon give en ofrin.
NUM 7:55 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:56 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:57 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:58 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:59 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Gamaliel, wey Pedahzur born, give.
NUM 7:60 For di ninet day, Abidan wey Gideoni born, wey dey lead Benjamin tribe, kon give en ofrin.
NUM 7:61 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:62 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:63 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:64 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:65 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Abidan wey Gideoni born give.
NUM 7:66 For di tent day, Ahiezer wey Ammishaddai born, wey bi leader for Dan tribe, kon give en ofrin.
NUM 7:67 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:68 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:69 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:70 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:71 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahiezer, wey Ammishaddai born, give.
NUM 7:72 For di elevent day, Pagiel wey Okran born, wey dey lead Asher pipol, kon give en ofrin.
NUM 7:73 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:74 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
NUM 7:75 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:76 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:77 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Pagiel, wey Okran born, give.
NUM 7:78 For di twelft day, Ahira wey Enan born, wey bi leader for Naftali pipol, kon give en ofrin.
NUM 7:79 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
NUM 7:80 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
NUM 7:81 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
NUM 7:82 one man goat for klean ofrin;
NUM 7:83 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahira, wey Enan born, give.
NUM 7:84 Dis na di whole ofrin wey di leaders for Israel give for di altar, wen dem don anoint am: twelf silva plate, twelf shine-shine silva bowl and twelf gold pan.
NUM 7:85 Each silva plate heavy rish one hundred and three shekel and each shine-shine silva bowl heavy rish seventy shekel. All di silva vessel dem heavy rish 2,400 shekel, akordin to di sanctuary shekel.
NUM 7:86 Di twelf gold pans wey incense full heavy rish ten shekel and na akordin to di sanctuary shekel; all di pan wey bi gold heavy rish one hundred and twenty shekel.
NUM 7:87 All di animal wey dem use for di burnt ofrin na twelf small melu, twelf ram, twelf man lamb wey bi one year, with dia korn ofrin and twelf man goat for klean ofrin.
NUM 7:88 All di animals wey dem sakrifice for peace ofrin na twenty-four small melu, sixty ram, sixty man goat and sixty lamb wey bi one year. Dis na di whole ofrin wey dem give to take dedikate di altar afta dem don anoint am.
NUM 7:89 Naw, wen Moses don enter di tent, God kon tok to am for di Kovenant Box top; between di two image wey bi like angel wey dem dey koll cherubim.
NUM 8:1 God kon tell Moses:
NUM 8:2 “Go tell Aaron sey make e put di seven lamp for where di lite go for dey shine for di lampstand front.”
NUM 8:3 So Aaron do as dem tell am. E put di lamp for di lampstand front, just as God kommand Moses.
NUM 8:4 Dis na how dem take make di lampstand: from di top go rish bottom, dem make am with gold, just as God show Moses.
NUM 8:5 God tell Moses:
NUM 8:6 “Make yu take Levi pipol komot for where Israel pipol dey kon wosh dem, so dat dem go dey holy.
NUM 8:7 Dis na how yu go take make dem holy: Sprinkol di holy wota for dia body, den tell dem sey make dem shave di hair for dia whole body kon wosh dia klot, so dat dem go dey holy.
NUM 8:8 Dem go take one small melu with korn ofrin wey bi fine flower wey dem mix with olive oil; den yu go take anoda small melu for di holy ofrin.
NUM 8:9 Yu go take Levi pipol kom di tent where dem for dey do meetin kon gada all di kommunity for Israel.
NUM 8:10 Yu go take Levi pipol kom where God dey and Israel pipol go put dia hand for Levi pipol head;
NUM 8:11 den Aaron go offa Levi pipol to God as special ofrin from Israel, so dat dem go do God work.
NUM 8:12 “Levi pipol go put dia hand on-top di two melu head; dem go give one as ofrin to klean demsef and di oda one as burnt ofrin, so dat dem go dey holy.
NUM 8:13 Yu go offa Levi pipol to God and Aaron and en sons go kare for dem.
NUM 8:14 So yu go separate Levi pipol from di oda pipol for Israel and Levi pipol go kon bi my own.
NUM 8:15 “Afta dis, Levi pipol go-go do my work for di tent wey dem for dey do meetin. So yu must klean and give dem to God as special ofrin.
NUM 8:16 I don use dem take replace all di first-born for Israel and dem bi my own forever.
NUM 8:17 Wen I kill all di first-born wey dey Egypt, I make all di first sons and animal for Israel holy, so dat dem go bi my own.
NUM 8:18 So I don use Levi pipol replace all di first-born sons for Israel.
NUM 8:19 From among Israel pipol, I don give Levi pipol as gift to Aaron and en sons, so dat dem go do di work wey Israel pipol suppose do for di tent where dem for dey do meetin and dem go guide Israel pipol from di wahala wey go happen if dem go near di sanctuary.”
NUM 8:20 So Moses, Aaron and Israel pipol kon offa Levi pipol, just as God kommand.
NUM 8:21 Levi pipol go klean and wosh dia klot, den Aaron give dem as special gift to God. E still do di sakrifice to make dem holy.
NUM 8:22 Di pipol do all di tins wey God kommand Moses about Levi pipol. So Levi pipol kon dey do di work for di tent where dem for dey do meetin and na Aaron and en sons, bi dia oga.
NUM 8:23 God tell Moses,
NUM 8:24 “From doz wey bi twenty-five years go among Levi pipol, na dem go do God work for di tent where dem for dey do meetin
NUM 8:25 and dem go ritaya wen dem don rish fifty years.
NUM 8:26 Dem fit help dia brodas for di work; dey give dem wetin dem wont, but make dem nor do any work. Dis na wetin yu go tell Levi pipol to do koncerning dia work for di sanctuary.”
NUM 9:1 God tell Moses for Sinai Wildaness sey, “For di first mont for di sekond year afta dem don komot from Egypt:
NUM 9:2 Israel pipol must do di Passova for di rite time.
NUM 9:3 For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”
NUM 9:4 So Moses tell Israel pipol sey make dem dey do di Passova.
NUM 9:5 And dem kon do di Passova for di fourteent day for evening and na di first mont for Sinai Wildaness, just as God kommand Moses.
NUM 9:6 Some pipol wey nor dey klean, bikos dem go tosh dead body, nor fit keep di Passova for dat day. So dem go meet Moses and Aaron
NUM 9:7 kon sey, “Even doh wi nor dey klean, bikos wi tosh dead body, wi nor go fit join Israel pipol give God ofrin?”
NUM 9:8 Moses ansa dem, “Make una wait until God go tell mi wetin I go do.”
NUM 9:9 God tell Moses:
NUM 9:10 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘If any of una or una shidren nor dey klean, bikos e go tosh dead body or e waka go far place, but e still wont keep di Passova,
NUM 9:11 e go fit do am, but e go bi di fourteent day for di sekond mont for evening; di bread wey dem nor make with yist, dem go chop am with bitter leaf.
NUM 9:12 Dem must nor leave any food till morning, or break any part for en bone; dem must do am akordin to di Passova law.
NUM 9:13 If pesin dey klean and e nor travel, but e nor gri keep di Passova, make una remove am from among my pipol, bikos e nor give mi di ofrin for di rite time. E must sofa for di sin wey e kommit.
NUM 9:14 “ ‘If strenja wey dey with una won keep di Passova, dem must do am akordin to all di rules and law. Na di same law di strenja and una own pipol go obey.’ ”
NUM 9:15 For di day wen dem build di Tabanako finish, di kloud kon kover di Tabanako and di Kovenant Box and from evening go rish morning, di kloud bi like fire for evriwhere for di Tabanako.
NUM 9:16 Dis na how e always bi: Di kloud go kover am for day time and fire go kover am for nite.
NUM 9:17 Wen ever di kloud komot from di Tabanako, Israel pipol go kontinue dia journey and anywhere wey di kloud for kom down, Israel pipol go kamp for der.
NUM 9:18 Just as God kommand, Israel pipol go travel or stay one place and as long as di kloud still dey di Tabanako, dem nor go-go anywhere.
NUM 9:19 Wen di kloud don stay for di Tabanako tey, Israel pipol go do evritin wey God kommand dem and dem nor go travel.
NUM 9:20 Wen di kloud dey for di Tabanako for some days, dem go dey dia kamp, just as God kommand dem.
NUM 9:21 Sometaims, di kloud dey only kom down from evening till morning and wen di kloud don go for morning, dem go kon kontinue dia journey. Weda na day time or nite, wen ever di kloud nor dey, dem go travel.
NUM 9:22 Weda na for two days, one mont, one year or if e tey pass so, as long as di kloud still kover di Tabanako, dem nor go komot go anywhere; but wen di kloud nor dey, dem go kontinue dia journey.
NUM 9:23 Just as God kommand, dem go stay for one place or travel, bikos dem dey obey di words wey God kommand Moses.
NUM 10:1 God tell Moses:
NUM 10:2 “Make yu make two trumpet with silva from one hammer. Yu go use am take dey gada di kommunity and to tell dem wen dem won travel.
NUM 10:3 Wen dem blow di two trumpet, all di kommunity must gada round yu for di tent where dem for dey do meetin door-mot.
NUM 10:4 But if dem blow one, den di leaders and doz wey dey lead tazon go kom meet yu.
NUM 10:5 Wen yu blow alarm, di pipol wey dey di east side must start to travel.
NUM 10:6 Wen yu blow for di sekond time, di pipol wey dey di sout-side must start to travel.
NUM 10:7 Yu must blow di trumpet wen yu gada di kommunity, but make yu nor sound alarm.
NUM 10:8 “Na only di priests wey bi Aaron shidren-shidren must blow di trumpet. Dis law na forever and una must obey am from one generashon go rish anoda.
NUM 10:9 If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies.
NUM 10:10 And for di time wen una dey happy like di time for una festival or as di mont just dey start; una go blow di trumpet for una burnt ofrin and di sakrifice wey una dey do for peace ofrin, so dat God go dey remember una: Na mi bi di Oga una God.”
NUM 10:11 For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box.
NUM 10:12 So Israel pipol start to travel from Sinai Wildaness. Di kloud kon kom down for Paran Wildaness.
NUM 10:13 Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses.
NUM 10:14 Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem.
NUM 10:15 Netanel wey Zuar born, na-im dey lead Issakar tribe.
NUM 10:16 Na Eliab wey bi Helon pikin dey lead Zebulun pipol.
NUM 10:17 Den dem karry di Tabanako go down and Gershon and Merari shidren kon karry di Tabanako as dem kontinue dia journey.
NUM 10:18 Di next tribe wey follow na Reuben pipol and dem kon dey waka with dia flag. Na Elizur wey Shedeur born dey lead dem.
NUM 10:19 Shelumiel wey Zurishaddai born, na-im dey lead Simeon pipol.
NUM 10:20 Den Eliasaf wey bi Deuel pikin kon dey lead Gad pipol.
NUM 10:21 Kohat pipol waka go karry di tins for di sanctuary and before dem go rish der, dem must don karry di Tabanako up.
NUM 10:22 Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem.
NUM 10:23 Gamaliel wey Pedahzur bi en papa, na-im dey lead Manasseh tribe
NUM 10:24 and Abidan wey Gideoni born dey lead Benjamin tribe.
NUM 10:25 Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem.
NUM 10:26 Pagiel wey Okran born, na-im dey lead Asher pipol
NUM 10:27 and Ahira wey en papa bi Enan dey lead Naftali tribe.
NUM 10:28 Dis na di way Israel pipol take travel; family by family.
NUM 10:29 Moses tell en wife broda Hobab wey en papa na Reuel wey kom from Midian sey, “Wi won start to travel go di place wey God don sey E go give us. E don promise to make Israel prosper, so make yu follow us and wi go trit yu well.”
NUM 10:30 But Hobab ansa, “I nor go follow una, instead I go-go my own land go meet my pipol.”
NUM 10:31 Moses kon sey, “Make yu nor leave us, bikos na Yu know where wi go stay for inside di wildaness and na yu go bi awa eye.
NUM 10:32 If yu follow us, wi go share all di blessings wey God go give us, with yu.”
NUM 10:33 Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small.
NUM 10:34 As dem dey travel, God kloud dey kover dem.
NUM 10:35 And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey, “My God! Arise make yor enemies dem skata and make all doz wey hate Yu, run as dem si Yu dey kom.”
NUM 10:36 And wen di box stop, Moses go sey, “My God! Make Yu kom back kom meet Israel, yor pipol wey plenty.”
NUM 11:1 Di pipol kon dey komplain to God about dia problem. Wen God hear dem, E vex, so E send fire kom from heaven kon burn and distroy some part for di kamp.
NUM 11:2 Di pipol kry go meet Moses make e help dem; so Moses pray to God and di fire kon stop.
NUM 11:3 So dem kon koll dat place “Taberah” bikos na for der God fire take burn di pipol.
NUM 11:4 Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!
NUM 11:5 Wen wi dey for Egypt, wi dey chop any fish wey wi wont for free. Remember di cucumber, wotamelon, leeks, onions and di garlic dem wey wi dey chop.
NUM 11:6 But naw, wi don dry finish. Nor-tin dey to chop, unless dis manna wey wi dey chop evriday!”
NUM 11:7 (Manna bi like small-small seed wey en kolour na lite yellow.
NUM 11:8 Di pipol go-go gada am for groun kon grind or pound am for mortar; den dem go take am bake kake. Di kake dey taste like fresh olive oil.
NUM 11:9 And wen di dew dey fall for nite, di manna dey kom with am.)
NUM 11:10 Moses hear kry for evry family among di pipol; evribody dey for dia tent door-mot; so Moses nor dey happy, bikos God dey vex with dem.
NUM 11:11 So Moses tell God, “Why Yu dey trit mi like dis? Why Yu sey make I kare for dis pipol?
NUM 11:12 Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?
NUM 11:13 Na where I go for get meat for all dis pipol, bikos dem dey kry give mi sey, ‘Make yu give us meat make wi chop?’
NUM 11:14 I nor go fit karry all dis pipol by mysef! Di load two heavy for only mi!
NUM 11:15 E betta sey make Yu kill mi, dan sey make Yu dey trit mi like dis. If really sey Yu dey good to mi, den make Yu allow dis trobol pass mi.”
NUM 11:16 God ansa Moses, “Make yu gada seventy men among di eldas for Israel wey yu know sey bi leaders among di pipol, den bring dem kom di Tabanako with yu.
NUM 11:17 I go kom down kon tok with yu, I go take some of di Spirit wey dey inside yu kon put am inside dem and dem go help yu karry some of di wahala so dat yu nor go karry am on yor own.
NUM 11:18 “Make yu tell di pipol make dem klean demsef, bikos dem go get meat to chop tumoro. God don hear una komplain and kry for meat and as una dey sey, ‘Wi dey okay for Egypt before!’ Naw, God go give una meat chop.
NUM 11:19 Una go chop am, nor bi only for one day or two; or five, ten or twenty days,
NUM 11:20 but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”
NUM 11:21 But Moses ansa God, “I get 600,000, sojas with mi and Yu still dey sey, ‘I go give dem meat for one full mont!’
NUM 11:22 Even if wi kill all awa animals, dem go rish us chop? Even if wi katch all di fish wey dey di sea, e go rish di pipol?”
NUM 11:23 Den God ansa, “So yu tink sey God hand short well-well? Naw, yu go si weda my word go happen or not!”
NUM 11:24 So Moses komot go tell di pipol wetin God tok. E kon pick seventy men wey bi leaders for Israel wey go follow am stand for di Tabanako.
NUM 11:25 God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.
NUM 11:26 Two out of di seventy men, Eldad and Medad kon stay for di kamp and dem nor go where di Tabanako dey. But di Spirit enter dem for where dem dey and dem kon start to profesai too.
NUM 11:27 One yong man run go tell Moses wetin Eldad and Medad dey do.
NUM 11:28 Den Joshua wey Nun born, wey dey help Moses since e dey yong kon tell Moses sey, “My oga, make yu stop dem!”
NUM 11:29 Moses ansa, “Yu dey jealous? I for wish sey God give en Spirit to all en pipol, so dat all of dem go dey profesai!”
NUM 11:30 Den Moses and di seventy leaders kon go back to di kamp.
NUM 11:31 Den God send breeze wey karry one kind bird wey dem dey koll kwail from di sea kom and dem fall kon high rish three fit for di groun. Dem dey evriwhere for di kamp, even for far-far place and for evry direcshon.
NUM 11:32 So for dat day, for nite and di next day, di pipol kon dey gada di bird. Nobody gada less dan 1,000 kilogram. Dem spread dem round di kamp, so dat dem go dry.
NUM 11:33 As dem still dey chop di meat, God kon dey vex with di pipol, so E send sickness go meet dem.
NUM 11:34 So dem kon name dat place Kibrot Hattaavah (Long-trot Grave), bikos na der dem for beri di pipol wey dey ask of meat.
NUM 11:35 From der, di pipol travel go Hazerot kon kamp and stay der.
NUM 12:1 Den Miriam and Aaron kon tok against Moses, bikos e go marry one woman from Ethiopia.
NUM 12:2 Dem kon sey, “Na only thru Moses God dey tok to us? E neva still tok thru us too?” But God hear dem.
NUM 12:3 (Naw, na Moses honbol pass anybody wey dey di eart.)
NUM 12:4 At wons, God tell Moses, Aaron and Miriam sey: “Make una three kom meet mi for di Tabanako.” So dem kon go.
NUM 12:5 God kom down inside kloud, stand for di tent gate; den E koll Aaron and Miriam and di two of dem waka go front.
NUM 12:6 God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.
NUM 12:7 My savant Moses nor bi like dat; e dey faithful for my house.
NUM 12:8 So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”
NUM 12:9 God kon dey vex with dem so E komot der.
NUM 12:10 Wen di kloud komot di tent, leprosy kon full Miriam body like snow. Den Aaron look Miriam, kon si sey leprosy full en body!
NUM 12:11 So Aaron tell Moses, “My oga, abeg, nor let us sofa dis ponishment bikos of awa foolish sin.
NUM 12:12 Nor let us mi bi like pikin wey don die, wey e flesh don rotin before dem born am.”
NUM 12:13 Den Moses kry to God kon sey, “My God, abeg make Yu listin to am.”
NUM 12:14 God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”
NUM 12:15 So dem porshu Miriam komot di kamp for seven days and di pipol nor travel until dem bring am kom back.
NUM 12:16 Den di pipol komot from Hazerot kon go kamp for Paran Wildaness.
NUM 13:1 God tell Moses:
NUM 13:2 “Make yu send men go shek Kanaan land wey I won give Israel pipol. Yu go send one man from each of di twelf tribe. Make each one bi leader for en tribe.”
NUM 13:3 So Moses send dem komot from Paran Wildaness, just as God kommand. All di men wey e send, na leaders for Israel.
NUM 13:4 Na dia names bi dis: From Reuben tribe, e send Shammua wey Zakkur born;
NUM 13:5 from Simeon tribe, e send Shafat wey Hori born;
NUM 13:6 from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;
NUM 13:7 from Issakar tribe, e send Igal wey Josef born;
NUM 13:8 from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;
NUM 13:9 from Benjamin tribe, e send Palti wey Rafu born;
NUM 13:10 from Zebulun tribe, e send Gaddiel wey Sodi born;
NUM 13:11 from Josef tribe (wey bi Manasseh tribe), e send Gaddi wey Susi born;
NUM 13:12 from Dan tribe, e send Ammiel wey Gemalli born;
NUM 13:13 from Asher tribe, e send Setur wey Mikael born;
NUM 13:14 from Naftali tribe, e send Nahbi wey Vopshi born;
NUM 13:15 from Gad tribe, e send Geuel wey Maki born.
NUM 13:16 Dis na di men wey Moses send go shek di land. Hoshea wey Nun born, Moses kon shange en name to Joshua.
NUM 13:17 Wen Moses send dem go shek Kanaan land, e tell dem, “Make una go thru Negev and all di hill kountries
NUM 13:18 and si wetin di land bi like. Weda di pipol wey dey stay der strong or weak, small or plenty,
NUM 13:19 or weda di land dey good or bad; weda di towns wey dem dey stay bi like kamp or betta town;
NUM 13:20 weda di land dey rish or poor; get forest or not. Make una dey strong kon bring some fruit wey dey di land kom.” Naw, dis na di time for di year wen di first grape dey ripe.
NUM 13:21 So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat.
NUM 13:22 Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.)
NUM 13:23 Wen dem rish Eshkol Valley, dem kon kut one branches wey grape full and two men karry am with stik. Dem still take some pomegranate fruit and fig follow body.
NUM 13:24 Dem koll di place Eshkol Valley, bikos of di many grape wey Israel pipol kut from der.
NUM 13:25 Den, dem kon kom back afta forty days, wen dem don shek di land.
NUM 13:26 Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.
NUM 13:27 Dem tell Moses, “Wi go di land wey yu send us. True-true, milk and honey full der and dis na di fruit wey dey der.
NUM 13:28 But na strong and big pipol dey stay der and di town get betta wall and dem dey guide am well-well. Wi still si Anak shidren-shidren for der.
NUM 13:29 Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
NUM 13:30 Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”
NUM 13:31 But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.”
NUM 13:32 So dem make Israel pipol bilive sey dem nor go fit konker di land wey dem go spy kon dey sey, “Di land nor go fit produce food for all di pipol wey dey stay der. All di pipol wey wi si der, big well-well
NUM 13:33 and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”
NUM 14:1 Den di pipol kon kry and dem kry well-well till di next day.
NUM 14:2 Israel pipol kon bigin komplain against Moses and Aaron sey, “E for betta sey wi die for Egypt or for di wildaness!
NUM 14:3 Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”
NUM 14:4 So dem kon dey tell demsef sey, “Make wi choose new leader wey go take us go Egypt back!”
NUM 14:5 Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front.
NUM 14:6 Joshua wey Nun born and Kaleb wey Jefunneh born wey dey among di men wey go shek di land kon tear dia klot, bikos dem dey vex
NUM 14:7 den dem sey, “Di land wey wi go shek dey good well-well.
NUM 14:8 If God dey happy with us, E go take us go der kon give us dat land wey full with milk and honey.
NUM 14:9 Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”
NUM 14:10 But di pipol kon dey plan to stone Joshua and Kaleb. Den God lite kon appear to Israel pipol for di Tabanako.
NUM 14:11 Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present?
NUM 14:12 I go strike dem with diziz kon distroy dem, den I go make anoda nashon thru yu and e go dey great and mighty pass dem!”
NUM 14:13 But Moses ansa, “Na Yu bring dis pipol komot from Egypt with yor pawa. Egypt pipol know wetin Yu don do for yor pipol wen Yu save dem.
NUM 14:14 Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.
NUM 14:15 If Yu kill all yor pipol, di nashons wey don hear about Yu go kon sey,
NUM 14:16 ‘Na bikos Yu nor fit take yor pipol go di land wey Yu promise dem, naim make Yu kill dem for di wildaness.’
NUM 14:17 “So my God, I dey pray, make Yu show yor pawa kon give us wetin Yu promise wen Yu sey,
NUM 14:18 ‘Mi wey bi God, I nor dey kwik vex and I dey show my love and goodness well-well. I dey forgive pipol sins and sturbones, but I go still ponish dia shidren-shidren go rish dia third and fourt generashon, bikos of di sin wey dia papa and mama kommit.’
NUM 14:19 Abeg, make Yu forgive dis pipol akordin to yor love wey nor dey shange; wey strong well-well, just as Yu take forgive dem for Egypt kon rish naw.”
NUM 14:20 Den God ansa, “I don forgive dem as yu tok.
NUM 14:21 But I promise sey, as long as I dey,
NUM 14:22 non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.
NUM 14:23 Doz wey rijet mi nor go ever enter di land wey I promise dia grand-grand papa.
NUM 14:24 But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.
NUM 14:25 (Naw Amalek and Kanaan pipol dey stay for di valley.) Tumoro, make una turn back kon travel go di wildaness for di road wey dey near di Red Sea.”
NUM 14:26 God tell Moses and Aaron:
NUM 14:27 “How long I go take bear di evil wey di pipol dey tok about mi? I don hear Israel pipol komplain about mi.
NUM 14:28 Make una tell dem sey, ‘As long as I dey, I go do anytin wey yu sey make I do. Na mi wey bi God tok am.
NUM 14:29 Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land.
NUM 14:30 I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.
NUM 14:31 Una sey dem go katch una shidren, but I go take dem go di land wey una rijet and e go bi dia own.
NUM 14:32 Una go die for dis wildaness.
NUM 14:33 Una go waka anyhow for di wildaness for forty years kon sofa until di last pesin among una go die, bikos una nor good at-all.
NUM 14:34 Akordin to di days wey una take shek di land, na so too una go sofa for una sin for forty years; one day go bi for one year, den una go know how e bi to make mi vex!’
NUM 14:35 Mi God don sey, ‘I go do wetin I tell dis wiked pipol wey gada togeda against mi. All of dem go die for dis wildaness. Mi wey bi God, don tok.’ ”
NUM 14:36 Di men wey Moses send go shek di land, wey kom back kon make Israel pipol dey komplain against God, bikos of di bad tin wey dem tok about di land;
NUM 14:37 doz men wey bring di evil ripot about di land, God kon kill dem with diziz.
NUM 14:38 And out of di twelf pipol wey Moses send go shek di land, na only Joshua and Kaleb, remain.
NUM 14:39 Wen Moses tell Israel pipol wetin God tok, dem kon dey komplain more-more.
NUM 14:40 Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.”
NUM 14:41 But Moses ansa dem, “Den why una kon dey disobey God? Una nor go fit win!
NUM 14:42 Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una,
NUM 14:43 bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”
NUM 14:44 But dem still go di kountry on-top di hill, even doh God Kovenant Box and Moses nor dey with dem.
NUM 14:45 Amalek and Kanaan pipol for der kon attack and porshu dem go rish Hormah.
NUM 15:1 God tell Moses,
NUM 15:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I go give una,
NUM 15:3 make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,
NUM 15:4 den di one wey dey give en ofrin to God must go bring each animal with one kilogram of flower wey dem mix with one lita of olive oil for korn ofrin,
NUM 15:5 togeda with one lita of wine for drink ofrin.
NUM 15:6 “ ‘If na ram e one give, two kwota for flower wey dem mix with one and half lita of olive oil and na dem e go give as korn ofrin,
NUM 15:7 with one and half lita of wine, as drink ofrin. God like dis sakrifice smell well-well.
NUM 15:8 “ ‘If na melu dem give God as burnt ofrin or as sakrifice to take pay dia vow or fellowship ofrin,
NUM 15:9 dem go bring korn ofrin of six kwota for flower wey dem mix with two lita of olive oil, den
NUM 15:10 two lita of wine, as drink ofrin. God like dis sakrifice smell well-well.
NUM 15:11 Na so too una go prepare each sakrifice wey bi melu, ram, sheep or goat.
NUM 15:12 If dem give more dan one ofrin, di ofrin wey go follow am go inkrease.
NUM 15:13 “ ‘All di pipol wey dem born for Israel go do like dis anytime wey dem won give ofrin, bikos God like di ofrin smell well-well.
NUM 15:14 And if strenja dey stay among una, weda na for sometaim or forever and dem won offa ofrin wey get sweet smell to God, dem must follow di rules and regulashon.
NUM 15:15 Na di same law una and strenjas wey dey with una go obey forever, bikos all of una na di same for God eye;
NUM 15:16 di same law and rules naim all of una go obey forever.’ ”
NUM 15:17 God tell Moses:
NUM 15:18 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I dey take una go
NUM 15:19 and una chop some of di food wey dey di land, una must keep some as special ofrin to God.
NUM 15:20 Una go give kake from una first flower wey una grind as special ofrin, just as una do for di first korn wey una grind.
NUM 15:21 Una and una shidren-shidren must give God some for di first flower wey una grind as special ofrin forever.
NUM 15:22 “ ‘If una nor know kon kommit sin and break di kommand wey God give una thru Moses,
NUM 15:23 all wetin God kommand una thru Moses, from di day wey God kommand Moses go rish una shidren-shidren,
NUM 15:24 den if una do anytin wey nor kom from una mind and di kommunity nor know about am, di kommunity must give one yong melu as burnt ofrin to take klean demsef.
NUM 15:25 Den di priest go do di sakrifice for di kommunity and I go forgive dem, bikos dem nor sin from dia mind and dem don bring dia ofrin; ofrin wey dem make with God fire and ofrin to klean demsef for God present, bikos of di sin wey dem nor kommit from dia mind.
NUM 15:26 I go forgive all di kommunity and di strenjas wey dey stay with dem, bikos na all of dem kommit di sin wey nor kom from dia mind.
NUM 15:27 “ ‘If anybody kommit di sin wey nor kom from en mind, den e must give one goat wey bi one year to take klean ensef.
NUM 15:28 Di priest must do di sakrifice for di pesin wey kommit di sin, den I go forgi-am.
NUM 15:29 Una must get one law for di pesin wey nor kommit sin from en mind, both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with una.
NUM 15:30 “ ‘But anybody wey kommit sin with en mind, weda dem born am for Israel or na strenja, dat pesin don curse God and dem must kill-am,
NUM 15:31 bikos e nor gri do wetin God tok or obey en kommand. Na en use en hand kill ensef.’ ”
NUM 15:32 Wen Israel pipol still dey for wildaness, dem si one man dey pak wood for Sabat Day.
NUM 15:33 Di pipol wey si am kon take am go meet Moses, Aaron and di kommunity.
NUM 15:34 Dem put di man for prison make sojas guide am, bikos dem nor know wetin dem go do am.
NUM 15:35 Den God tell Moses, “Di man must die; make di whole kommunity take am go outside di kamp kon stone am till e die.”
NUM 15:36 So di whole kommunity take am go outside di kamp kon stone am till e die, just as God kommand Moses.
NUM 15:37 God tell Moses:
NUM 15:38 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Make dem tie tread for dia klot forever kon use blue tread dekorate di korna.
NUM 15:39 Una must get dis tread, so dat wen una look am, una go remember all God kommand kon do dem and una nor go allow una heart or eye turn una from mi.
NUM 15:40 Like dat, una go remember and obey my kommand kon dey holy to una God.
NUM 15:41 Na mi bi di Oga una God; wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi God.’ ”
NUM 16:1 Naw some pipol from Reuben tribe kon sin, dis pipol na: Korah wey Izhar born, wey Kohat born, wey Levi born with Datan and Abiram wey Eliab bi dia papa and On wey Pelet born.
NUM 16:2 Dem with some Israel pipol (two hundred and fifty popula prince from di kommunity) kon dey tok against Moses.
NUM 16:3 Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
NUM 16:4 Wen Moses hear wetin dem tok, e bow for groun kon start to pray.
NUM 16:5 Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place.
NUM 16:6 Tumoro morning yu and doz wey dey follow yu: make una bring una burn ofrin kontaina.
NUM 16:7 Una go lite fire, put incense inside, den karry am go di altar. Den wi go si di pesin own wey God go take. Levi pipol, na una own worse pass!”
NUM 16:8 Moses tell Korah pipol again, “Levi pipol, make una listin to mi!
NUM 16:9 Una tink sey e nor mean anytin to God wey choose una among Israel pipol to dey near am, so dat una go fit serve am for en Tabanako kon stand and dey prish to di pipol?
NUM 16:10 E don already give dis tins to both una and una fellow Levi pipol. And naw, una sey una won bi priest too!
NUM 16:11 So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”
NUM 16:12 So Moses koll Datan and Abiram wey Eliab born, but dem ansa am, “Wi nor go kom.
NUM 16:13 Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?
NUM 16:14 Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”
NUM 16:15 Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”
NUM 16:16 Den Moses tell Korah, “Tumoro make yu and doz wey dey follow yu kom stand for God present and Aaron go kom too.
NUM 16:17 Make each of una take en own kontaina with incense kom meet God: Both Aaron and una two hundred and fifty kontaina with incense. Each pesin among una with en own kontaina wey incense full.”
NUM 16:18 So all of dem take dia kontaina with incense kon lite fire put, den dem stand for di tent where dem for dey do meetin door-mot, with Moses and Aaron.
NUM 16:19 Wen Korah gada di kommunity against Moses and Aaron for di tent door-mot, God glory kon appear to di whole kommunity.
NUM 16:20 God tell Moses and Aaron:
NUM 16:21 “Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”
NUM 16:22 Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”
NUM 16:23 So God tell Moses:
NUM 16:24 “Make yu tell di whole kommunity sey: ‘Make dem komot from Korah, Datan and Abiram tent.’ ”
NUM 16:25 So Moses get up go meet Datan and Abiram and di eldas for Israel, follow am.
NUM 16:26 E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.”
NUM 16:27 So dem komot from Korah, Datan and Abiram tent. Den Datan and Abiram kom out kon stand for di tent door-mot with dia wifes and shidren.
NUM 16:28 Moses kon sey, “Na so una go take know sey na God send mi kom do dis work, bikos I nor dey do am by mysef.
NUM 16:29 If dis men die normal deat without sey God ponish dem, den nor bi God send mi.
NUM 16:30 But if God do sometin wey neva happen before and di eart open swallow dem with all wetin dem get and dem die alive, den una go know sey dis men don rijet God.”
NUM 16:31 Wen e tok finish, di groun under Datan and Abiram open
NUM 16:32 kon swallow dem, with dia tent, all Korah men and with all dia propaty.
NUM 16:33 Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity.
NUM 16:34 Israel pipol wey dey der kon run komot wen dem hear di pipol dey kry. Dem kon dey shaut sey, “Make wi run o-o! Di eart fit swallow us too!”
NUM 16:35 Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.
NUM 16:36 God tell Moses:
NUM 16:37 “Make yu tell Eleazar wey Aaron di priest born sey, make e pick di kontaina wey dem dey put incense komot from di fire, bikos dem dey holy, den make dem pak di shako go far.
NUM 16:38 Di pipol wey die bikos of dia sin, make una use dia kontaina take make wetin dem go take kover di altar, bikos dem offa am to God, so dem dey klean. Dem go bi sign for Israel pipol.”
NUM 16:39 So Eleazar take di bronze kontaina kon use dem do kover for di altar.
NUM 16:40 Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.
NUM 16:41 But for di next day, di whole kommunity kon dey komplain against Moses and Aaron sey, “Una don kill God pipol.”
NUM 16:42 Afta dem gada against Moses and Aaron, dem turn face di tent where dem for dey do meetin kon si di kloud kover am and God glory kon appear.
NUM 16:43 Den Moses and Aaron stand for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 16:44 God tell Moses,
NUM 16:45 “Make yu komot from dis kommunity, so dat I go distroy dem naw-naw!” Moses and Aaron kon bow face groun.
NUM 16:46 Den Moses tell Aaron, “Make yu take di kontaina with incense kon put fire inside am from di altar. Den kwik go di kommunity side go do sakrifice to make dem holy, bikos God go send one bad diziz kon meet dem, since E dey vex for dem.”
NUM 16:47 So Aaron do wetin Moses kommand and e run enter di pipol centre. Naw di diziz just dey start among di pipol. Aaron put di incense for der kon make dem holy.
NUM 16:48 E stand between doz wey don die and doz wey dey alive kon stop di diziz.
NUM 16:49 Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter.
NUM 16:50 Afta di diziz stop, Aaron kon go meet Moses for di tent door-mot.
NUM 17:1 God tell Moses:
NUM 17:2 “Make yu tok to Israel pipol kon kollect stik from each tribe; one from evry leader wey dey each tribe, yu go kollect twelf stik kon rite each man name put for en stik.
NUM 17:3 Den yu must rite Aaron name put for Levi pipol stik; bikos each stik na for di leader for each tribe.
NUM 17:4 Yu go put dem for di tent where dem for dey do meetin near di Kovenant Box where I for meet yu.
NUM 17:5 And di man stik wey I go choose go prosper; so I go stop Israel pipol to dey komplain against yu.”
NUM 17:6 So Moses tok to Israel pipol and each leader gi-am one stik, one for each leader akordin to dia tribe. So all di stik na twelf; Aaron stik dey among.
NUM 17:7 Moses put di stik before God for di tent where dem for dey meet.
NUM 17:8 Di next day, Moses enter di tent and Aaron stik for Levi house kon dey grow well-well with leaf, den e form one kind fruit wey dem dey koll almond!
NUM 17:9 So Moses bring all di stik kom out from God present kon show Israel pipol and each pesin kon take en stik.
NUM 17:10 Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.”
NUM 17:11 So Moses do wetin God kommand am.
NUM 17:12 Israel pipol kon tell Moses, “Na die wi dey so!
NUM 17:13 If anybody wey go near God Tabanako, go die, dat mean sey all of us don die finish?”
NUM 18:1 God tell Aaron, “Yu, yor sons and yor tribe must sofa for di Tabanako sin; but only yu and yor sons go sofa for di priest sins.
NUM 18:2 Make yu karry yor brodas, Levi tribe and yor papa tribe follow body, so dat dem go join and help yu wen yu and yor sons dey for di tent.
NUM 18:3 Dem must kare for yu and di whole Tabanako. But dem must nor kom near di holy tins for di Holy Place and di altar or all of una go die.
NUM 18:4 Dem must work with yu kon kare for di tent where dem for dey do meetin and for all di work wey dey di tent, but anybody wey nor kwalifai, make e nor work with yu.
NUM 18:5 “Na yu go kare for di sanctuary and di altar, so dat problem nor go follow Israel pipol again.
NUM 18:6 Even mi mysef don choose yor brodas; Levi pipol for Israel. God give dem to yu as gift wey go do di work for di tent where dem for dey meet.
NUM 18:7 But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”
NUM 18:8 God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever.
NUM 18:9 Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons.
NUM 18:10 Yu must chop am for di Most Holy Place and evry boy pikin fit chop am, bikos e go dey holy to yu.
NUM 18:11 “And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.
NUM 18:12 “I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.
NUM 18:13 And any first fruit wey ripe for dia land wey dem give God, go bi yor own. Evribody wey dey klean for yor family go fit chop am.
NUM 18:14 “Anytin for Israel wey dem give to God, go bi yor own.
NUM 18:15 Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.
NUM 18:16 Dem go take di shidren back wen dem don rish one mont kon pay five shekel for silva akordin to di sanctuary shekel.
NUM 18:17 “But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God.
NUM 18:18 But dia meat go bi yor own, just as di breast and di rite leg bi yor own.
NUM 18:19 All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”
NUM 18:20 God tell Aaron, “Yu nor get any propaty for dia land and know part for Israel land go bi yor own. Na mi God, bi evritin wey yu nid.
NUM 18:21 “I don give Levi pipol all di tithes wey Israel pipol give mi. Dis na to pay dem for dia work wey bi to kare for di tent where dem for dey do meetin.
NUM 18:22 Di oda Israel pipol nor go kom near di tent where dem for dey do meetin again, or dem go bear dia sin and dem go die.
NUM 18:23 But Levi pipol must do di work for di tent where dem for dey do meetin and dem must bear dia own sin. Dis na rule forever for all Levi pipol. Levi pipol nor go get any propaty for Israel,
NUM 18:24 bikos I don give dem di tithes wey Israel pipol give mi. Dat na why I sey dem nor go get any propaty for Israel.”
NUM 18:25 God kommand Moses:
NUM 18:26 “Make yu go tell Levi pipol sey: ‘Wen una don kollect Israel pipol tithes wey God don give una as una own, una must divide am into ten kon give one part as special ofrin to God.
NUM 18:27 Den God go kollect una special ofrin as E take kollect farmer own for new korn and wine.
NUM 18:28 God special ofrin and tithes wey una kollect from Israel pipol, una go give dem to Priest Aaron.
NUM 18:29 From all una gifts, una must give di special ofrin wey bi God own and e must bi di best and e go dey holy.’
NUM 18:30 “So make yu Moses tell dem, ‘Wen una don give di best, una fit keep di rest, just as farmer dey keep wetin remain afta e don give en ofrin.
NUM 18:31 Una fit chop am for anywhere; both una and una family, bikos na una salari for una work for di tent where dem for dey do meetin, bi dat.
NUM 18:32 And una nor go kommit any sin, since na di best part una give. Una must dey kareful, so dat una nor go trit di holy tins wey Israel pipol get, anyhow, bikos if una do am, una go die.’ ”
NUM 19:1 God tell Moses and Aaron:
NUM 19:2 “Dis na my kommand: ‘Make una tell Israel pipol make dem bring red melu wey dey okay and wey dem neva use take work before.
NUM 19:3 Dem must gi-am to Eleazar wey bi priest, so dat e go karry am komot from di kamp, den dem go kill-am for en present.
NUM 19:4 Priest Eleazar go take some of di blood with en finger kon sprinkol am seven times evriday for front of di tent where dem for dey do meetin.
NUM 19:5 Di full animal, plus di skin, meat, blood and intestine, dem go burn am for di priest present.
NUM 19:6 Den di priest go take cedar wood, hyssop leaf and one red rope kon put dem for fire.
NUM 19:7 Di priest go wosh en klot kon baf with wota, den e go fit enter di kamp, but di priest go dey unklean till evening.
NUM 19:8 Di pesin wey burn di melu must wosh en klot with wota kon baf, but e go dey unklean till evening.
NUM 19:9 Den di man wey dey klean, go kollect di melu ashes kon go keep dem for klean place for outside di kamp and Israel pipol go use dem take prepare di wota wey dem go take make pipol holy. Dem dey do dis sakrifice to remove sin.
NUM 19:10 Di man wey gada di ashes must wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis law na forever both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem.
NUM 19:11 “ ‘Anybody wey go tosh dead body go dey unklean for seven days.
NUM 19:12 E must use klean wota take klean ensef for di third and sevent day, den e go dey holy. But if e nor klean ensef for di third and sevent day, e nor go dey holy.
NUM 19:13 Anybody wey tosh human being dead body and e nor klean ensef, don dirty Oga God temple. So make una drive dat pesin komot from Israel pipol, bikos dem nor klean am with di wota wey dem dey use klean pipol wey nor klean.
NUM 19:14 “ ‘Na di law bi dis: “If anybody die for di tent, evribody wey dey di tent wen di pesin die or wey enter, go dey unklean for seven days.
NUM 19:15 And evry kontaina for di tent wey nor get kover, go dey unklean.”
NUM 19:16 Anybody wey tosh pesin wey dem kill with swod for war or anybody wey tosh dead body, human being bone or grave, go dey unklean for seven days.
NUM 19:17 “ ‘Pesin wey dey klean go take some of di ashes from di melu wey dem burn for sin kon put am for pot, den pour fresh wota inside.
NUM 19:18 Den e go bring hyssop leaf, deep am for wota kon sprinkol am for di tent, evritin for inside; for di pipol wey dey der and for di pesin wey tosh dead body, pesin bone or grave.
NUM 19:19 For di third and sevent day, di pesin wey dey klean go sprinkol di wota for di unklean pesin body. For di sevent day, e go santify di man den di man go wosh en klot kon baf, den e go dey klean for evening.
NUM 19:20 But di man wey nor dey klean or neva klean ensef, go remain unklean, bikos dem neva sprinkol di klean wota for en body. E don spoil Tabanako and dem must separate am from God pipol.
NUM 19:21 Una go obey dis law forever. “ ‘Di pesin wey sprinkol di klean wota must go wosh en klot and anybody wey tosh di wota go dey unklean till evening.
NUM 19:22 Anytin wey unklean pesin tosh, go dey unklean and any oda pesin wey go tosh am go dey unklean till evening too.’ ”
NUM 20:1 For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.
NUM 20:2 Wota nor dey, so di pipol kon gada round Moses and Aaron
NUM 20:3 dey komplain sey: “E for betta sey all of us die for di tent for God present!
NUM 20:4 Wetin make yu bring us kom dis wildaness, so dat wi go die with awa animals?
NUM 20:5 Why yu take us komot from Egypt kom dis evil place where nor-tin dey grow? No korn, fig, grape or pomegranate fruit for here. Wota to drink sef nor even dey!”
NUM 20:6 Moses and Aaron komot from di pipol front go enter di tent. Dem bow face groun and God glory kon appear to dem.
NUM 20:7 God tell Moses,
NUM 20:8 “Make yu take di stik and yu and Aaron yor broda go gada di kommunity, den tok to di rock for dia front and wota go kom out. Like dis yu go bring wota out from rock for di pipol, both for dem and dia animals.”
NUM 20:9 So Moses take di stik from God present, just as God kommand am.
NUM 20:10 En and Aaron kon gada di whole kommunity for di rock front, den Moses sey, “Make una listin! Una wey sturbon well-well! Make wi bring wota out from rock for una?”
NUM 20:11 Den Moses raiz en hand kon nak di rock two times with en stik. Plenty wota rush kom out, den evribody for Israel and dia animals kon drink beleful.
NUM 20:12 Den God tell Moses and Aaron, “Bikos una nor trust mi well-well to show di pipol how I dey holy rish, una nor go take dem enter di land wey I dey give una.”
NUM 20:13 Dis tin happen for Meribah where Israel pipol for komplain against God and God show dem how E dey holy.
NUM 20:14 Moses kon send message from Kadesh go give Edom king sey: “Di message na from yor broda Israel: Yu know all di sofa wey wi dey sofa,
NUM 20:15 how awa grand-grand papa go Egypt where wi stay for many years. How Egypt pipol ponish us and awa grand-grand papa well-well.
NUM 20:16 So wen wi kry to God, E hear awa vois kon send messenja, wey kom take us komot from Egypt. Naw, wi dey Kadesh, di town wey dey una kountry side.
NUM 20:17 Wi beg make una allow us waka pass una kountry. Wi nor go waka pass una field or vineyard. Wi nor go drink wota from any well. Wi go waka just as di king go tell us. Wi go stay for di main road until wi komot from una aria.”
NUM 20:18 But Edom king ansa, “Una nor go fit waka pass awa kountry, if una try am, wi go attack una.”
NUM 20:19 Israel pipol kon sey, “Wi go stay for di main road and if any of us or awa animals drink yor wota, wi go pay for am, wi just won waka pass.”
NUM 20:20 But Edom ansa, “Una nor go fit waka pass.” Den Edom kom out kon attack Israel pipol with plenty sojas.
NUM 20:21 Edom nor gri make Israel pipol waka pass, so dem kon waka pass anoda place.
NUM 20:22 So di whole kommunity for Israel komot from Kadesh go Mount Hor.
NUM 20:23 And God tell Moses and Aaron for Mount Hor, near Edom borda sey,
NUM 20:24 “Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah.
NUM 20:25 Make yu take Aaron and Eleazar en pikin kom Mount Hor.
NUM 20:26 Den remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar, bikos Aaron go die for der.”
NUM 20:27 Moses do wetin God kommand am. Dem kon go Mount Hor for di whole kommunity present.
NUM 20:28 Den Moses remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar. Aaron die on-top di mountin, den Moses and Eleazar kon kom back.
NUM 20:29 Di whole kommunity know sey Aaron don die, den dem kon mourn for am for thirty days.
NUM 21:1 King Arad for Kanaan wey dey stay Negev, hear sey Israel pipol dey kom from Atarim, so e kon attack and kapture some of dem.
NUM 21:2 Den Israel pipol kon make vow to God sey: “If Yu diliver dis pipol give us, wi go distroy dia town.”
NUM 21:3 God hear Israel pipol prayer kon diliver Kanaan pipol to dem and dem distroy dem and dia towns. So dem kon koll dat place, “Hormah.”
NUM 21:4 Den dem travel from Mount Hor near di Red Sea, go round Edom land, but di pipol kon dey hurry anyhow for road.
NUM 21:5 Di pipol tok against God and Moses sey, “Why Yu take us komot from Egypt make wi for die for dis wildaness wey bread or wota nor dey and wi don taya for dis yeye food.”
NUM 21:6 So God send snake go bite di pipol and dem many wey die.
NUM 21:7 Den di pipol go meet Moses kon sey, “Wi don sin, bikos wi don tok against God and yu. Make yu pray to God make E take di snake komot from where wi dey.” So Moses kon pray for di pipol.
NUM 21:8 God tell Moses, “Make yu make snake put on-top pole and anybody wey snake bite wey look am, nor go die.”
NUM 21:9 So Moses make snake with bronze kon put am on-top pole, so dat di pipol wey snake bite, if dem look di snake wey dem make with bronze, dem nor go die.
NUM 21:10 Israel pipol travel kon kamp for Obot.
NUM 21:11 Den dem travel from Obot go stay for Iye-Abiram, for di wildaness wey dey before Moab, for di east side.
NUM 21:12 From der, dem kon travel go kamp for Zered Valley.
NUM 21:13 Den dem travel from der go di oda side for Amor for di wildaness wey wide from Amor, bikos Arnon na Moab borda wey dey between Moab and Amor.
NUM 21:14 Dis na why dem rite for God War Book sey, “Waheb town wey dey Sufah aria and di valleys; Arnon river,
NUM 21:15 di low valley wey rish Ar town klose to Moab boundary.”
NUM 21:16 So from der, dem kon go Beer; dat na di well where God for tok to Moses sey, “Make yu gada di pipol and I go give dem wota.”
NUM 21:17 Den Israel pipol kon sing dis song: “Make dis well kom up kon sing to God!
NUM 21:18 Di well wey di princess dig, wey di leaders open with dia septa and staff.” Dem travel from di wildaness go Mattanah;
NUM 21:19 from Mattanah to Nahaliel and from Nahaliel to Bamot.
NUM 21:20 Dem still travel from Bamot go di valley wey dey Moab kountry, on-top Pisgah wey face di wildaness.
NUM 21:21 Den, Israel pipol send messenja go meet King Sihon wey dey rule Amor sey,
NUM 21:22 “Make yu allow us pass yor land; wi nor go-go di field or vineyard; wi nor go drink wota from yor well, but wi go stay for di main road until wi don komot from yor aria.”
NUM 21:23 But King Sihon nor gri make Israel pipol pass en aria; instead e gada all en sojas kon go attack Israel pipol for di wildaness. Wen e rish Jahaz, e kon fight against Israel pipol.
NUM 21:24 But Israel pipol kill dia enemy well-well kon take di land from Arnon River for nort go rish Jabbok and Ammon side, but Ammon sojas bin guide dia aria well-well.
NUM 21:25 So Israel pipol take all dis towns kon stay for Amor, Heshbon and dia village dem.
NUM 21:26 Heshbon na King Sihon town for Amor. Naw, e don fight against di king wey dey Moab before kon take all en land from der go rish Arnon.
NUM 21:27 Dis na why dem sey, “Make yu kom Heshbon, so dat dem go build am. Make dem build King Sihon town again!
NUM 21:28 Bikos fire kom out from Heshbon, betta fire kom out from Sihon town. E don distroy Ar wey dey Moab and di ogas wey dey for Arnon.
NUM 21:29 Moab pipol, curse dey una head. Kemosh pipol, una don skata! Una make una sons dey run anyhow and una dotas don turn King Sihon for Amor, prisonas.
NUM 21:30 Wi don ova pawa dem; from Heshbon go rish Dibon and all dia pipol don die finish. Wi don skata dem go rish Nofah wey dey near Medeba.”
NUM 21:31 So Israel pipol kon dey stay for Amor pipol land.
NUM 21:32 Moses send men make dem go find di best way to attack Jazer town. Israel pipol katch di town, drive Amor pipol kon dey stay der.
NUM 21:33 Den, Israel pipol turn go pass di road wey lead to Bashan. King Og for Bashan kon go attack Israel pipol for Edrei.
NUM 21:34 God tell Moses, “Make yu nor fear am. I go make yu win en, all en pipol and en land. Make yu do to am wetin yu do King Sihon, di Amor king wey bin dey rule for Heshbon.”
NUM 21:35 So Israel pipol win and kill King Og, en sons and all en pipol, until nobody dey to kill again, den dem kon stay for en land.
NUM 22:1 Israel pipol kon travel go Moab for Jordan River for di oda side for Jeriko.
NUM 22:2 Balak wey Zippor born kon si all wetin Israel pipol don do to Amor pipol.
NUM 22:3 So Moab pipol kon dey fear, bikos Israel pipol plenty.
NUM 22:4 Den Moab pipol tell di eldas for Midian sey, “Dis plenty pipol go kon distroy evritin wey wi get, just as melu take dey chop grass for field.” Naw, King Balak wey Zippor born wey dey rule Moab pipol for dat time
NUM 22:5 kon send messenjas go koll Balaam wey Beor born for Petor, wey dey near di river for en town sey, “Si, one nashon don komot from Egypt. Dem plenty well-well for di eart and dem dey stay klose to mi.
NUM 22:6 So, I beg make yu kom help mi curse dis nashon, bikos dem too get pawa pass mi. May bi I go defeat and drive dem komot from di land. Bikos I know sey anybody wey yu bless, blessing go follow am and anybody wey yu curse, curse go follow am.”
NUM 22:7 So di eldas for Moab and Midian kon karry di curse money go meet Balaam. Dem meet Balaam kon tell am wetin Balak tok.
NUM 22:8 Balaam ansa dem, “Make una stay here dis nite and I go tell una anytin wey God tell mi.” So di eldas for Moab kon stay with Balaam.
NUM 22:9 God kom meet and ask Balaam, “Dis men wey dey with yu, na who dem bi?”
NUM 22:10 Balaam ansa, “Balak wey Zippor born, wey bi di king for Moab, naim send dem kom meet mi sey,
NUM 22:11 ‘Si! One nashon don kom out from Egypt and dem plenty well-well for di eart. So make yu kom help mi curse dem; may bi I go fit defeat and drive dem komot from here.’ ”
NUM 22:12 But God tell Balaam, “Make yu nor follow dem go and make yu nor curse di pipol, bikos I don bless dem.”
NUM 22:13 So Balaam get up for morning and e tell di prince dem wey Balak send sey, “Make una go una land, bikos God sey make I nor follow una.”
NUM 22:14 So di prince dem go back kon tell Balak sey, “Balaam nor gri follow us kom.”
NUM 22:15 Balak kon send some oda ofisas go again, wey plenty and dey important pass di first ones.
NUM 22:16 Dem go meet Balaam kon tell am, “Balak wey Zippor born sey: ‘Make yu nor allow anytin stop yu to kom help mi.
NUM 22:17 I go pay yu well and I go do anytin wey yu tok. Abeg make yu kom help mi curse dis pipol.’ ”
NUM 22:18 Balaam ansa, “Even if Balak give mi all di silva and gold wey dey en palis, I nor go fit disobey di Oga my God kommand, even if na for small matter.
NUM 22:19 But I dey beg make una stay dis nite, just as di oda pipol stay, make I si if God go tok anoda tin.”
NUM 22:20 Dat nite God appear to Balaam kon tell am, “If dis men sey make yu follow dem, ready make yu follow dem, but na only wetin I tell yu, na-im yu go do.”
NUM 22:21 So di next day for morning, Balaam enter en donkey kon follow di prince dem from Moab.
NUM 22:22 Den God vex sey Balaam follow dem, so God angel kon stand for road to stop am. Naw, Balaam dey drive di donkey and en two savants dey with am.
NUM 22:23 Den di donkey si God angel as e stand for di road with swod for en hand, so di donkey turn face di field. But Balaam beat di donkey, so dat e go turn face road.
NUM 22:24 Den God angel stand for where vineyard dey and wall dey for di two side.
NUM 22:25 Wen di donkey si God angel, e waka near di wall kon press Balaam leg against am. Den Balaam beat am again.
NUM 22:26 God angel go front kon stand for one small place, where road nor dey to turn go rite or go left.
NUM 22:27 Wen di donkey si God angel again, e kon lie down for groun. Den Balaam vex kon beat di am with en stik.
NUM 22:28 So God open di donkey mout and di donkey tell Balaam, “Wetin I do yu wey make yu dey beat mi so? Yu don beat mi three times!”
NUM 22:29 Balaam ansa di donkey, “Na bikos yu make mi look like fool: if to sey I get swod for my hand, I for don kill yu naw.”
NUM 22:30 Di donkey ansa, “Nor bi mi bi di donkey wey yu dey ride since kon rish today? I don ever trit yu like dis?” Den Balaam ansa, “No.”
NUM 22:31 Den God open Balaam eye and e si God angel as e stand for di road with swod for en hand; so e kon fall face groun.
NUM 22:32 God angel kon tell am, “Wetin make yu beat dis donkey three times? Si, I kom here kon stop yu, bikos wetin yu dey do, I nor like am.
NUM 22:33 Di donkey si mi kon turn from mi three times. If to sey e nor turn from mi, I for kill yu leave di donkey.”
NUM 22:34 Balaam kon tell God angel, “I don sin. I nor know sey yu stand against mi for di road. So if wetin I dey won go do nor dey good for yor eye, I go-go house back.”
NUM 22:35 But God angel ansa, “Make yu go with di men, but na only wetin I tell yu, na-im yu go tok.” So Balaam kon go with di prince dem wey kom from Balak.
NUM 22:36 Wen King Balak hear sey Balaam dey kom, e go outside go meet am for Moab town wey dey Arnon boundary for di aria.
NUM 22:37 Balak kon tell Balaam, “Why yu nor kom di first time wen dem kom koll yu? Yu tink sey I nor go fit pay yu?”
NUM 22:38 Balaam ansa am, “Naw I don kom, but I nor get pawa to tok wetin I wont. Na only wetin God tell mi, I go tok.”
NUM 22:39 So Balaam kon follow Balak go Kiriat-Huzot town,
NUM 22:40 where Balak for kill kattle and sheep kon give some meat to Balaam and di prince dem wey dey with am.
NUM 22:41 Den di next morning, Balak kon take Balaam go Bamot Baal where e go for fit si some Israel pipol from far.
NUM 23:1 Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.”
NUM 23:2 So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar.
NUM 23:3 Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.
NUM 23:4 God kom meet Balaam and Balaam sey, “I don build di seven altar and I don give one melu and one ram for each one.”
NUM 23:5 Den God tell Balaam, “Go back go meet Balak, tell am wetin I tell yu.”
NUM 23:6 So Balaam go meet Balak for where en stand (near en burnt ofrin), both en and all di prince dem for Moab.
NUM 23:7 Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’
NUM 23:8 Na how I wont take curse pipol wey God nor curse? Or how I go take distroy wen God nor send mi?
NUM 23:9 I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon.
NUM 23:10 Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.”
NUM 23:11 Den Balak tell Balaam, “Wetin yu do mi so? I sey make yu help mi curse my enemy, but yu kon dey bless dem!”
NUM 23:12 Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.”
NUM 23:13 Balak kon tell am, “Abeg, follow mi go anoda place where yu go si some Israel pipol, den help mi curse dem from der.”
NUM 23:14 So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.
NUM 23:15 Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”
NUM 23:16 God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.”
NUM 23:17 Wen Balaam kom back, e si sey Balak still stand near di burnt ofrin, with di prince dem for Moab. So Balak ask, “Na wetin God tok?”
NUM 23:18 Balaam kon profesai, “Make una kom! Balak wey Zippor born, make yu kom hear wetin I dey tok.
NUM 23:19 God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.
NUM 23:20 E don kommand mi make I bless dem and wen God bless pesin, I nor go fit shange am.
NUM 23:21 Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king.
NUM 23:22 Na God take dem komot from Egypt; E dey fight for dem like wiked melu.
NUM 23:23 Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’
NUM 23:24 Israel pipol go bi like strong lion wey nor dey rest until e don distroy en enemies kon drink di blood of di pesin wey e kill.”
NUM 23:25 Den Balak tell Balaam, “As yu nor gri curse Israel pipol, den make yu nor bless dem!”
NUM 23:26 But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?”
NUM 23:27 Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.”
NUM 23:28 So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.
NUM 23:29 Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.”
NUM 23:30 So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.
NUM 24:1 Wen Balaam si sey God wont make e bless Israel, e nor kon go meet God as before, but e turn waka go near di wildaness.
NUM 24:2 As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.
NUM 24:3 Den e start to profesai: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
NUM 24:4 di man wey dey hear wetin God dey tok. Pesin wey dey si vishon from God, even as en eye open. So e sey:
NUM 24:5 ‘Si as Israel tent fine, di place where Jakob dey stay!
NUM 24:6 Dem bi like long valley; like gardin wey dey near wotaside. Dem bi like aloe wey God plant and cedar tree wey dem plant near wota.
NUM 24:7 Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.
NUM 24:8 God take dem komot from Egypt. E dey fight for dem like wiked melu. Dem kill and break sturbon pipol bones kon shuk dem with arrow.
NUM 24:9 Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’ ”
NUM 24:10 Den Balak kon dey vex well-well for Balaam, so e klap en hand kon tell Balaam, “I koll yu make yu kon curse my enemies, but si, yu don bless dem three times!
NUM 24:11 So naw, make yu dey go! I sey I go pay yu well; but naw, God nor wont make I pay yu.”
NUM 24:12 Balaam tell Balak sey, “I tell di messenjas wey yu send to mi sey,
NUM 24:13 ‘Even if yu give mi yor house with all yor silva and gold, I nor go fit disobey God kommand to do evil or good just as I wont am, but na anytin wey God tell mi, I go tok.’
NUM 24:14 I dey go meet my pipol naw, but make I warn yu about wetin dis pipol go soon do yor pipol.”
NUM 24:15 Den Balaam profesai sey: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
NUM 24:16 di man wey dey hear wetin God tok, wey know di tins wey dey di Most High mind; di one wey dey si vishon from di Almighty, even as en eye open. So e kon sey:
NUM 24:17 ‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.
NUM 24:18 E go take-ova Edom town and propaty; den Israel pipol go win.
NUM 24:19 Dem go bring leader from Jakob house and e go distroy di pipol wey remain for di town.’ ”
NUM 24:20 Den Balaam look Amalek pipol kon profesai: “Before-before, na Amalek strong pass among di nashons, but e go skata forever.”
NUM 24:21 Den e look Kenite pipol kon profesai: “Where una dey stay strong well-well and dey save like bird house on-top tree.
NUM 24:22 But dem go distroy Kenite pipol. How long Asshur go use una as slave?”
NUM 24:23 Den e profesai kon sey: “Yes! Na who go dey alive wen God don do all dis tins!
NUM 24:24 Strenjas go kom from Cyprus kon ovakom Assyria and Eber, but dem too, go die forever.”
NUM 24:25 Den Balaam and Balak kon go dia house.
NUM 25:1 Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen.
NUM 25:2 Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju.
NUM 25:3 Bikos Israel pipol join dem woship Baal-Peor, God kon dey vex well-well for dem.
NUM 25:4 God tell Moses, “Arrest all di leaders kon hang dem before di Oga for aftanoon, so dat mi God nor go vex for Israel pipol again.”
NUM 25:5 So Moses tell di judge dem wey dey Israel sey, “Each of una must kill doz men among una wey dey woship Baal-Peor.”
NUM 25:6 At wons, one Israel man bring one Midian woman enter di tent where Moses and di whole kommunity for dey kry.
NUM 25:7 Wen Finehas wey Eleazar born, Aaron di priest grand-pikin si am, e komot from where all di pipol gada, take spear
NUM 25:8 follow di Israel man enter en tent, den kill di two of dem. So di wahala wey dey distroy Israel pipol kon stop.
NUM 25:9 Doz wey die for di wahala na 24,000.
NUM 25:10 God tell Moses:
NUM 25:11 “Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex.
NUM 25:12 So make yu tell am sey: ‘I go gi-am my kovenant wey dey bring peace.
NUM 25:13 Na en get am and en shidren go bi priest forever, bikos e take en God sirious kon make mi forgive dis pipol.’ ”
NUM 25:14 Di Israel man wey dem kill with dat Midian woman, na Zimri wey Salu born, wey bi leader for Simeon tribe.
NUM 25:15 Di Midian woman wey dem kill, na Cozbi wey Zur born. Zur na leader for Midian tribe.
NUM 25:16 Den God kommand Moses,
NUM 25:17 “Make yu attack and distroy Midian pipol,
NUM 25:18 bikos dem bring wahala to una wen dem deceive una koncerning Peor and bikos of Cozbi, wey die for di time wey Peor bring wahala enter una land.”
NUM 26:1 Afta di wahala, God kon tell Moses and Aaron pikin Eleazar sey,
NUM 26:2 “Make una kount di kommunity for Israel akordin to dia family, from twenty years go, doz wey go fit work as soja for Israel.”
NUM 26:3 So Moses and Aaron pikin Eleazar, tok to di pipol for Moab near Jordan River wey dey across Jeriko. Dem kon sey,
NUM 26:4 “Make una kount di pipol from twenty years go, just as God kommand Moses. Dis na Israel pipol wey kom out from Egypt.”
NUM 26:5 Reuben na di first-born for Israel. Reuben shidren na: Hanok family, Pallu family,
NUM 26:6 Hezron family and Karmi family.
NUM 26:7 Dis na Reuben family and doz wey dem kount na 43,730.
NUM 26:8 Pallu pikin na Eliab.
NUM 26:9 Eliab sons na, Nemuel, Datan and Abiram. Na Datan and Abiram with Korah komplain against Moses, Aaron and God.
NUM 26:10 Di eart open kon swallow and kill dem with Korah. Di pipol wey di fire distroy, na 250 men. Wetin happen to dem kon bi warnin to di rest pipol.
NUM 26:11 But di sons wey Korah born, nor die.
NUM 26:12 Simeon shidren akordin to dia family na: Nemuel family; Jamin family; Jakin family;
NUM 26:13 Zera family and Shaul family.
NUM 26:14 Dis na Simeon family and dem bi 22,200.
NUM 26:15 Gad shidren akordin to dia family na: Zefon family; Haggi family: Shuni family;
NUM 26:16 Ozni family; Eri family;
NUM 26:17 Arod family and Areli family.
NUM 26:18 Dis na Gad family and dem bi 40,500.
NUM 26:19 Judah shidren na Er and Onan, but Er and Onan die for Kanaan land.
NUM 26:20 And Judah shidren akordin to dia family na: Shelah family; Perez family and Zera family.
NUM 26:21 Perez family na: Hezron family and Hamul family.
NUM 26:22 Dis na Judah family and dem bi 76,500.
NUM 26:23 Issakar shidren akordin to dia family na: Tola family; Puah family;
NUM 26:24 Jashub family and Shimron family.
NUM 26:25 Dis na Issakar family and dem bi 64,300.
NUM 26:26 Zebulun shidren akordin to dia family na: Sered family; Elon family and Jahleel family.
NUM 26:27 Dis na Zebulun family and dem bi 60,500.
NUM 26:28 Josef shidren akordin to dia family na: Manasseh and Efraim.
NUM 26:29 Manasseh family na: Makir family. Na Makir bi Ramot papa. Wi get Gilead family
NUM 26:30 and from am wi get: Iezer family; Helek family;
NUM 26:31 Asriel family; Shekem family;
NUM 26:32 Shemida family and Hefa family.
NUM 26:33 Naw Zelofehad wey Hefa born nor get any man pikin, but na only wimen e born and dia names na Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
NUM 26:34 Dis na Manasseh family and dem bi 52,700.
NUM 26:35 Efraim shidren akordin to dia family na: Shutela family; Beka family and Tahan family.
NUM 26:36 Na Shutela shidren bi Eran family.
NUM 26:37 Dis na Efraim family and dem bi 32,500. All dis na Josef shidren-shidren akordin to dia family.
NUM 26:38 Benjamin shidren akordin to dia family na: Bela family; Ashbel family; Ahiram family;
NUM 26:39 Shufam family and Hufam family.
NUM 26:40 Bela shidren na Ard and Naaman.
NUM 26:41 Dis na Benjamin family and dem bi 45,600.
NUM 26:42 Dan shidren akordin to dia family na: Shuham family. Dis na Dan shidren, akordin to dia family:
NUM 26:43 dis na Shuham family and dem bi 64,400.
NUM 26:44 Asher shidren akordin to dia family na Imnah family; Ishvi family and Beraya family.
NUM 26:45 From Beraya shidren, wi still get Heba family; Malkiel family.
NUM 26:46 Asher dota name na Serah.
NUM 26:47 Dis na Asher family and dem bi 53,400.
NUM 26:48 Naftali shidren akordin to dia family na: Jahziel family; Guni family;
NUM 26:49 Jeza family and Shillem family.
NUM 26:50 Dis na Naftali family and dem bi 45,400.
NUM 26:51 Di total nomba for Israel men wey dem kount na 601,730.
NUM 26:52 Den God tell Moses:
NUM 26:53 “Make yu divide di land between di difren tribes, akordin to dia size.
NUM 26:54 Any tribe wey plenty, yu go give dem big land and di tribe wey small, yu go give dem small land. Yu go give evry tribe akordin to dia nomba.
NUM 26:55 Yu go trow dice take divide di land and dem go get dia porshon akordin to di tribe wey dem from kom.
NUM 26:56 Dem go get dia share with di dice akordin to di group wey small or big pass.”
NUM 26:57 Levi pipol wey dem kount akordin to dia family na: from Gershon pipol, Kohat pipol and Merari pipol.
NUM 26:58 Dis na Levi family and dem bi: Libni family, Hebron family, Mahli family, Mushi family and Kohat family. Na Kohat born Amram.
NUM 26:59 Amram wife name na Jokebed, Levi dota wey dem born for Egypt. Di woman born Aaron, Moses and dia sista Miriam give Amram.
NUM 26:60 Aaron pikin na: Nadab and Abihu, Eleazar and Itama.
NUM 26:61 But Nadab and Abihu die wen dem go offa anoda ofrin to God.
NUM 26:62 Doz wey dem kount na 23,000. All di men from one mont go wey dem nor kount among Israel pipol, dem nor give dem any propaty for Israel.
NUM 26:63 Dis na doz wey Moses and Eleazar di priest kount among Israel pipol for Moab near Jordan River wey face Jeriko.
NUM 26:64 But nobody among dis pipol dey wen Moses and Aaron bin kount dem for Sinai Wildaness.
NUM 26:65 God don tok about dem sey, “Dem go must die for di wildaness.” And nobody among dem go remain, escept Kaleb wey Jefunneh born and Joshua wey Nun born.
NUM 27:1 Den di dotas wey Zelofehad wey Hefa born, wey Gilead born, wey Makir born, wey Manasseh born wey Josef born kon kom. Di girls names na, Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
NUM 27:2 Dem stand before Moses, Eleazar di priest, di leaders and all di pipol wey gada for di tent where dem for dey do meetin door-mot kon sey,
NUM 27:3 “Awa papa die inside wildaness, aldo e nor join Korah pipol and doz wey gada demsef against God; but e die bikos of en own sin.
NUM 27:4 Wetin go make awa papa name lost from en family, bikos e nor get man pikin? So make yu give us propaty from di ones wey awa papa family get.”
NUM 27:5 So Moses take dia kase go meet God.
NUM 27:6 God tell Moses:
NUM 27:7 “Zelofehad dotas ask for wetin dey rite. So yu must give dem dia papa propaty among dia family.
NUM 27:8 “Yu must tell Israel pipol sey, ‘If man die and e nor get man pikin, den una go give en propaty to en dotas;
NUM 27:9 and if e nor get dotas, den una go give en propaty to en brodas;
NUM 27:10 but if e nor get brodas, den una go give en papa brodas en propaty;
NUM 27:11 if en papa nor get brodas, den una go give en propaty to di pesin wey dey klose to am pass for en family and e go take am. Dis go bi law wey Israel must obey, bikos na God kommand.’ ”
NUM 27:12 Den God tell Moses, “Klimb go Abarim Mountin, so dat yu go si di land wey I don give Israel pipol.
NUM 27:13 Wen yu don si am, yu go die, just as yor broda Aaron take die.
NUM 27:14 Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”
NUM 27:15 Den Moses tell God:
NUM 27:16 “Oga God wey dey give life, make Yu choose one man wey go lead di pipol,
NUM 27:17 pesin wey go-go out before dem and kom back before dem and wey go lead dem, so dat God pipol nor go bi like sheep wey nor get who dey guide dem.”
NUM 27:18 God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;
NUM 27:19 tell am make e stand before Eleazar di priest; before all di kommunity, den announce am as di pesin wey go take-ova from yu.
NUM 27:20 Give am some of yor pawa, so dat all di kommunity go obey am.
NUM 27:21 E go stand before Eleazar wey go-go hear from God akordin to di Urim. Akordin to en kommand, dem go-go out and kom in, both en and all Israel pipol.”
NUM 27:22 Moses do as God kommand am. E sey make Joshua stand before Eleazar di priest and di whole kommunity for Israel.
NUM 27:23 E put en hand for Joshua head kon sey na-im go take-ova from am. E do evritin, just as God kommand am.
NUM 28:1 God tell Moses:
NUM 28:2 “Make yu kommand Israel pipol sey: ‘Make una give God di rite food ofrin wey go make belle sweet am.
NUM 28:3 Dis na di food ofrin wey una go give to God evriday: two man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 28:4 Make una give di first lamb for morning and di sekond one for evening,
NUM 28:5 each one with di korn ofrin wey bi one kilogram for flower, wey dem mix with one lita of di best olive oil.
NUM 28:6 Dis na di evriday burnt ofrin wey dem go first give for Mount Sinai as dia food ofrin, bikos na betta ofrin e bi to God.
NUM 28:7 For di wine ofrin with di first lamb, make una pour one lita for di altar.
NUM 28:8 For evening, make una give di sekond lamb as una take give di first ofrin togeda with en wine ofrin. Na food ofrin e still bi and God like di smell well-well.
NUM 28:9 “ ‘For di Sabat Day, una must give two man lamb wey bi one year and dem must dey okay; two kilogram for flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and di wine ofrin.
NUM 28:10 Dis burnt ofrin go bi for evry Sabat Day plus di ofrin wey dem dey give evriday with en wine ofrin.
NUM 28:11 “ ‘Make una give di burnt ofrin to God as each mont start: two yong melu; one ram; seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
NUM 28:12 Una go add all dis tins join di korn ofrin wey dem mix; six kwota of flower with each melu, four kwota with each ram and
NUM 28:13 two kwota with each lamb. Dis burnt ofrin go bi special gift and God dey like di smell.
NUM 28:14 Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont
NUM 28:15 Una go still dey offa di evriday burnt ofrin with en wine ofrin and one man goat as sin ofrin.
NUM 28:16 “ ‘For di fourteent day for di first mont, una go dey do di Passova Feast to tank God.
NUM 28:17 For di fifteent day for di mont, una go start one holy festival wey go end for di sevent day and for doz days, na only bread wey nor get yist una go dey chop.
NUM 28:18 For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.
NUM 28:19 But una must offa food ofrin to God: two melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 28:20 Make una give di rite korn ofrin wey bi flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with di ram
NUM 28:21 and one kilogram with each lamb.
NUM 28:22 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
NUM 28:23 Make una give dis plus di normal morning burnt ofrin.
NUM 28:24 Like dis too, for seven days, make una give God food ofrin, di smell wey E dey like well-well. Make una give all dis ones, plus di evriday burnt and wine ofrin.
NUM 28:25 For di sevent day, make una gada woship and make una nor do any work.
NUM 28:26 “ ‘For di first day wen una dey do di harvest feast, wen una dey give di ofrin for new korn to God, una go gada woship and una nor go do any work.
NUM 28:27 Make una give burnt ofrin, di kind smell wey God like well-well, dat is: two yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 28:28 Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with di ram
NUM 28:29 and one kilogram with each lamb.
NUM 28:30 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
NUM 28:31 Una go offa dem with di wine ofrin plus di normal burnt and korn ofrin and dem must dey okay.
NUM 29:1 “ ‘For di first day for di sevent mont, una go gada woship mi. Una must nor do any work, bikos dat na di day wey dem go blow trumpet for una.
NUM 29:2 Make una give burnt ofrin to God, di smell wey God go like: make una give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
NUM 29:3 Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu; two kilogram with di ram,
NUM 29:4 and one kilogram with each lamb.
NUM 29:5 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
NUM 29:6 Make una give dis plus di normal burnt ofrin for di first day for di mont with en korn ofrin; di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin. Dis food ofrin get betta smell wey God like well-well.
NUM 29:7 “ ‘Make una gada woship God for di tent day for di sevent mont and make una nor chop food or do any work.
NUM 29:8 But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 29:9 Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu, two kilogram with di ram,
NUM 29:10 and one kilogram with each lamb.
NUM 29:11 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy and una go still give di evriday burnt ofrin with en korn ofrin.
NUM 29:12 “ ‘Make una gada woship God for di fifteent day for di sevent mont. Una go do dis to take honor God for seven days and una nor go do any work.
NUM 29:13 For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 29:14 Make una give di rite korn ofrin wey bi flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with each ram,
NUM 29:15 and one kilogram with each lamb.
NUM 29:16 Make una still give one goat as sin ofrin. Give dis plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:17 “ ‘For di sekond day, make una give twelf yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
NUM 29:18 Una go still give dia grain and wine ofrin with di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:19 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:20 “ ‘For di third day, una go give eleven melu, two ram, fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:21 with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:22 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:23 “ ‘For di fourt day, make una give ten melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:24 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:25 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:26 “ ‘For di fift day, make una give nine melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:27 with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:28 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:29 “ ‘For di sixt day, make una give eight melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:30 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:31 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:32 “ ‘For di sevent day, make una give seven melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:33 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:34 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:35 “ ‘For di eight day, make una gada woship and nor do any work.
NUM 29:36 Make una give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
NUM 29:37 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
NUM 29:38 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
NUM 29:39 “ ‘Dis na di law for burnt, grain, wine and fellowship ofrin wey una go give God wen una dey do di feast. Dis ones join di ofrin wey una go give to fulfil di vow or as free will ofrin.’ ”
NUM 29:40 So Moses tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
NUM 30:1 All di leaders for di tribe, Moses kon tell dem about Israel pipol sey, “Dis na wetin God kommand:
NUM 30:2 ‘If man make vow give God or take ensef take swear, e must nor break am, but e go do wetin e tok.
NUM 30:3 “ ‘If yong woman wey still dey stay en papa house make vow give God or promise with ensef
NUM 30:4 and en papa hear en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise.
NUM 30:5 But if en papa nor gri make e do wetin e vow wen e hear am, God go forgi-am, bikos en papa nor gri make e do am.
NUM 30:6 “ ‘If woman wey neva marry make vow, weda e know or e nor know, or promise and fail, den e kon marry,
NUM 30:7 if di husband hear about en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise.
NUM 30:8 But if di husband nor gri make e do wetin e vow, God go forgi-am.
NUM 30:9 “ ‘Woman wey en husband don die or dem nor dey togeda again, must do wetin e vow or promise.
NUM 30:10 “ ‘If woman wey don marry make vow or promise,
NUM 30:11 if di husband hear am and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise.
NUM 30:12 But if en husband nor gri make e do wetin e vow or promise, e fit nor do am and God go forgi-am, bikos na en husband nor gri make e do am.
NUM 30:13 So en husband get di rite to gri or nor gri make e do wetin e vow or promise.
NUM 30:14 But if di day afta e hear about di vow, e nor tok anytin, e must do evritin wey e vow or promise and since e nor tok anytin for di day wen e hear about am, e don agri with di vow wey di woman make.
NUM 30:15 But if leta e nor gri make e do wetin e vow, e go sofa, bikos e nor allow am do wetin e vow.’ ”
NUM 30:16 Dis na di law wey God give Moses about vow wey koncern, man and en wife; and about papa and en dota wey dey di same house.
NUM 31:1 God tell Moses:
NUM 31:2 “Make yu ponish Midian pipol, bikos of wetin dem do Israel pipol. Afta yu don do am, yu go die.”
NUM 31:3 So Moses tell di pipol, “Make una ready for war, so dat una go fit attack Midian pipol kon ponish dem for wetin dem do God pipol.
NUM 31:4 From each tribe wey dey Israel, make una send 1,000 men go war.”
NUM 31:5 So dem kon choose 1,000 men from each tribe and all di men wey ready for war, na 12,000.
NUM 31:6 So Moses send dem go war and na Finehas wey Eleazar di priest born bi dia leader. Na dis Finehas dey kare for di holy tins and di trumpet wey dem take dey give sign.
NUM 31:7 Dem attack and kill all di men for Midian, just as God kommand Moses.
NUM 31:8 Dem kill di five kings for Midian wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba. Dem still kill Balaam wey Beor born.
NUM 31:9 Israel pipol katch all di wimen and shidren for Midian kon karry all dia animals, propaty
NUM 31:10 den dem burn dia towns and kamps.
NUM 31:11 Dem take all dia propaty, plus di prisonas and animals
NUM 31:12 go give Moses, Eleazar and Israel pipol near di kamp for Moab wey dey di oda side for Jordan River near Jeriko.
NUM 31:13 Moses, Eleazar and all di oda leaders for di kommunity kon komot from di kamp go meet di sojas.
NUM 31:14 Moses vex with di ofisas and di leaders wen dem kom back from di war.
NUM 31:15 So e ask dem, “Why una nor kill all di wimen?
NUM 31:16 Remember sey na dis wimen obey wetin Balaam tok for Peor kon make di pipol sin against God. Dat na wetin curse wahala for God pipol.
NUM 31:17 So naw, make una kill all di boys and wimen wey don sleep with man,
NUM 31:18 but nor kill di girls and wimen wey neva sleep with man before.
NUM 31:19 “Naw all of una wey don kill pesin or wey tosh dead body go stay outside di kamp for seven days and for di third and sevent day, make una and di wimen wey una katch klean unasef.
NUM 31:20 Make una klean all una klot and evritin wey dem make with leda, goat hair, or wood.”
NUM 31:21 Eleazar di priest kon tell di men wey kom back from war sey, “Dis na di law wey God give Moses:
NUM 31:22 ‘Na only di gold, silva, bronze, iron, tin, lead
NUM 31:23 and evritin wey go fit pass thru fire, naim una go put for fire, so dat dem go dey holy, but anytin wey una nor fit put for fire, una go-go wosh am with wota.
NUM 31:24 Una must wosh una klot for di sevent day and una go dey holy, den una go fit enter di kamp.’ ”
NUM 31:25 Den God tell Moses:
NUM 31:26 “Make yu, Eleazar and di leaders take di propaty wey dem karry, both pipol and animals
NUM 31:27 kon share di propaty into two. One for doz wey go fight di war and di oda one for di whole kommunity.
NUM 31:28 From di sojas own, make yu take God tax komot; one from evry five hundred prisona and na di same tin for di animals.
NUM 31:29 Make yu give Eleazar all of dem as special ofrin to God.
NUM 31:30 From di ones wey dem give di oda pipol, make yu take one from evry fifty prisona and na di same tin for di animals. Yu go give all of dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako.”
NUM 31:31 So Moses and Eleazar kon do wetin God kommand.
NUM 31:32 All di good tins wey remain from di propaty wey di men wey go war karry, na 675,000 sheep;
NUM 31:33 dem still karry 72,000 kattle,
NUM 31:34 61,000 donkey,
NUM 31:35 plus 32,000 wimen wey neva sleep with man at-all.
NUM 31:36 Di half wey dem share give di sojas na 337,500 sheep;
NUM 31:37 God tax for di sheep na 675.
NUM 31:38 Di kattle wey dem kount na 36,000; God tax na 72.
NUM 31:39 Di donkey na 30,500; God tax na 61.
NUM 31:40 Di pipol kon bi 16,000, so God tax na 32 pipol.
NUM 31:41 So Moses give di tax wey bi God special ofrin to Eleazar di priest, just as God kommand am.
NUM 31:42 Wetin dem share give di kommunity na di same tin with wetin dem give di sojas.
NUM 31:43 So dem share 337,500 sheep kon give dem to di kommunity,
NUM 31:44 36,000 kattle,
NUM 31:45 30,500 donkey
NUM 31:46 and 16,000 pipol.
NUM 31:47 From evritin wey dem share give di kommunity, Moses take one from evry fifty kon give dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako, just as God kommand.
NUM 31:48 Den di ofisas wey dey kommand di soja kon go meet Moses
NUM 31:49 sey, “Oga God, wi don kount all di sojas wey dey under awa kommand and dem komplete.
NUM 31:50 So wi dey bring di gold ornaments, armlets, bracelets, rings, ear-rings and necklaces wey each of us take. Wi give dem to God as payment for awa life, so dat E go protet us.”
NUM 31:51 Moses and Eleazar kon take all di gold as ornament.
NUM 31:52 All di gold wey di ofisas give to God heavy rish 16,750.
NUM 31:53 Each soja don take propaty for ensef.
NUM 31:54 So Moses and Eleazar di priest kon take di gold from di ofisas go di tent, so dat God go protet Israel pipol.
NUM 32:1 Naw Reuben and Gad pipol get many kattle. Wen dem si sey Jazer and Gilead land dey good
NUM 32:2 dem kon go meet and tell Moses, Eleazar and di leaders sey,
NUM 32:3 “Atarot, Dibon, Jazer, Nimrah, Heshbon, Elealeh, Sebam, Nebo and Beon,
NUM 32:4 di land wey God don give Israel pipol dey good for kattle and yor savants get kattle.
NUM 32:5 So wi wont beg make una give us dis land as awa propaty. Make una nor make us cross Jordan River with una.”
NUM 32:6 Moses kon tell Gad and Reuben pipol sey, “Una won stay here make only una brodas go fight war?
NUM 32:7 Why una won diskorage Israel pipol make dem nor cross Jordan River go di land wey God don give dem?
NUM 32:8 Una papa do di same tin wen I send dem from Kadesh Barnea go si di land.
NUM 32:9 Wen dem si di land from Eshkol Valley, dem kon diskorage Israel pipol, so dat dem nor go enter di land wey God don give dem.
NUM 32:10 So God kon dey vex dat day and E swear sey,
NUM 32:11 ‘Bikos dem nor follow mi with all dia heart, no one among dem from twenty years go wey komot from Egypt go si di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob,
NUM 32:12 but Kaleb wey Jefunneh from Keniz born and Joshua wey Nun born go enter, bikos dem follow God with all dia heart.’
NUM 32:13 So God vex for Israel pipol kon make dem waka anyhow for di wildaness for forty years, until all di pipol wey do bad before God, die finish.
NUM 32:14 “Naw si, una don dey won bihave like una papa wey like sin. Una wont make God vex for Israel pipol again.
NUM 32:15 And if una nor follow am, E go leave una again for di wildaness and una go make am distroy odas.”
NUM 32:16 Den dem go near Moses kon sey, “Wi go build house here for awa animals and family,
NUM 32:17 but wi go follow awa brodas go war and wi go lead for di attack until dem don setol for di land wey go bi dia own. Awa shidren go dey here for sometaim for di house wey wi build to take protet dem from di pipol wey get di land.
NUM 32:18 Wi nor go-go awa house until all di tribe for Israel don get dia propaty.
NUM 32:19 Wi nor go take any propaty for di oda side for Jordan River or for front, bikos wi don get awa share for dis east side for Jordan River.”
NUM 32:20 Den Moses ansa dem, “If una go fit do dis tin kon dey ready to fight for God present
NUM 32:21 and all una sojas cross Jordan River as God kommand kon attack awa enemies until God defeat dem
NUM 32:22 and wi take di land as awa own, den una fit kom back, bikos una don do di work wey una suppose do for God and for Israel pipol. Den God go give una di land wey dey east for Jordan River.
NUM 32:23 “But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.
NUM 32:24 So make una build towns for una shidren and house for una animals, but make una do wetin una tok!”
NUM 32:25 Gad and Reuben pipol kon ansa, “Oga, wi go do wetin yu kommand.
NUM 32:26 Awa wifes, shidren and animals go dey here for Gilead.
NUM 32:27 But all of us don ready to go fight, just as God kommand. Wi go cross Jordan River go fight, just as yu tok.”
NUM 32:28 So Moses give Eleazar, Joshua and di oda leaders for Israel dis kommand sey:
NUM 32:29 “If Gad and Reuben pipol cross Jordan River go fight akordin to God kommand and if una konker di land with dia help, den una go give dem dis land as dia propaty.
NUM 32:30 But if dem nor cross Jordan River and dem nor go fight with una, den na Kanaan land dem go for get dia own land and propaty.”
NUM 32:31 Den Gad and Reuben pipol ansa, “Oga, wi go do wetin God kommand us.
NUM 32:32 Just as E kommand, wi go cross go Kanaan land go fight, so dat wi go get awa propaty for Jordan River east.”
NUM 32:33 So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.
NUM 32:34 Gad pipol kon ribuild Dibon, Atarot, Aroer,
NUM 32:35 Atrot Shofan, Jazer, Jogbehah,
NUM 32:36 Bet-Nimrah and Bet-Haran as strong towns, den dem make house for dia animals.
NUM 32:37 Reuben pipol kon ribuild Heshbon, Elealeh, Kiriataim,
NUM 32:38 Nebo, Baal-Meon (dem kon shange di name) and Sibmah. Di towns wey dem build, dem kon give dem new names.
NUM 32:39 Makir wey Manasseh born, en shidren go Gilead, drive Amor pipol wey dey stay der kon take di land.
NUM 32:40 So Moses give Gilead to Makir, wey Manasseh born and e kon dey stay der.
NUM 32:41 Naw, Jair wey Manasseh born kon go attack and take some small village and e name dem Havvot-Jair.
NUM 32:42 Den Nobah go attack and take Kenat and en village kon give dem en name, Nobah.
NUM 33:1 Dis na di place dem wey Israel pipol travel go, afta dem komot from Egypt akordin to dia tribe, just as Moses and Aaron kommand dem.
NUM 33:2 Akordin to God kommand, Moses kon rite di names of each place wey dem stay.
NUM 33:3 Israel pipol komot from Egypt for di fifteent day for di first mont wey bi di day afta di Passova. For Egypt pipol present, dem kon komot from Rameses town and God guide dem.
NUM 33:4 Naw, Egypt pipol beri all dia first-born pikin wey God kill and God still ponish dia juju.
NUM 33:5 Israel pipol travel from Rameses go Sukkot.
NUM 33:6 From Sukkot, dem go Etam wey dey klose to di wildaness.
NUM 33:7 Dem travel from Etam go Pi Hahirot wey dey before Baal-Zefon and dem kon stay near Migdol.
NUM 33:8 From Pi Hahirot dem travel pass di middle sea go di wildaness kon use three days travel go Etam Wildaness for Marah.
NUM 33:9 Dem travel from Marah go Elim; twelf wota fountain and seventy palm tree dey for Elim, so dem kon stay der.
NUM 33:10 Dem travel from Elim go stay near di Red Sea.
NUM 33:11 Den from di Red Sea, dem travel go Zin Wildaness.
NUM 33:12 From Zin Wildaness, dem go Dofkah.
NUM 33:13 And from Dofkah, dem travel go Alush.
NUM 33:14 Dem komot from Alush kon travel go Refidim, where wota nor dey for di pipol to drink
NUM 33:15 and from Refidim, dem kon go Sinai Wildaness.
NUM 33:16 Dem travel from Sinai Wildaness go stay Kibrot Hattaavah.
NUM 33:17 From Kibrot Hattaavah, dem kon go Hazerot and
NUM 33:18 from Hazerot, dem travel go stay Ritmah.
NUM 33:19 From Ritmah, dem travel go Rimon-Perez.
NUM 33:20 Dem travel from Rimon-Perez go Libnah.
NUM 33:21 From Libnah, dem kon travel go Rissah.
NUM 33:22 Dem travel from Rissah go Kehelatah.
NUM 33:23 Den dem kon travel from Kehelatah go Mount Shefa.
NUM 33:24 Dem travel from Mount Shefa go Haradah.
NUM 33:25 From Haradah, dem kon travel go Makhelot.
NUM 33:26 Dem travel from Makhelot go Tahat.
NUM 33:27 From Tahat, dem kon go Terah.
NUM 33:28 Dem travel from Terah go Mitcah.
NUM 33:29 And from Mitcah, dem travel go Hashmonah.
NUM 33:30 Dem travel from Hashmonah go Moserot
NUM 33:31 kon from Moserot go Bene Jaakan.
NUM 33:32 Dem travel from Bene Jaakan go Hor Haggidgad
NUM 33:33 kon travel from Hor Haggidgad go Jotbatah.
NUM 33:34 Dem travel from Jotbatah go Abrona.
NUM 33:35 From Abrona, dem kon go Ezion-Geber.
NUM 33:36 Dem travel from Ezion-Geber go Zin Wildaness, wey bi Kadesh.
NUM 33:37 Dem travel from Kadesh go Mount Hor wey dey near Edom.
NUM 33:38 Aaron di priest klimb Mount Hor akordin to God kommand and e die for der for di nomba forty years wey Israel pipol komot from Egypt land for di first day for di fift mont.
NUM 33:39 Naw Aaron na one hundred and twenty-three years wen e die for Mount Hor.
NUM 33:40 Arad and Kanaan pipol kings wey dey stay for di sout-side for di land wey dey Kanaan kon hear sey Israel pipol dey kom.
NUM 33:41 Dem travel from Mount Hor go Zalmonah.
NUM 33:42 From Zalmonah, dem travel go Punon
NUM 33:43 and from Punon, dem kon go Obot.
NUM 33:44 Dem travel from Obot go Iye-Abiram, wey dey near Moab.
NUM 33:45 Dem travel from Lim go Dibon
NUM 33:46 kon from der travel go Almon-Diblataim.
NUM 33:47 Dem travel from Almon-Diblataim go Abarim Mountin before Nebo.
NUM 33:48 Dem from Abarim Mountin go Moab plain land near Jordan River for where dem dey cross go Jeriko.
NUM 33:49 Dem kon stay for Jordan River, from Bet-Jeshimot go rish Abel-Shittim for Moab.
NUM 33:50 God tell Moses for Moab near Jordan River wey dey di oda side for Jeriko:
NUM 33:51 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una don cross komot from Jordan River go Kanaan land,
NUM 33:52 una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.
NUM 33:53 Una must drive all di pipol wey dey stay der komot kon stay for di land, bikos I don gi-am to una.
NUM 33:54 Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
NUM 33:55 But if una nor drive di pipol komot, den dem go dey give una problem and dem go trobol una for di land.
NUM 33:56 If una nor drive dem komot, I go distroy una, just as I plan to distroy dem.’ ”
NUM 34:1 Den God tell Moses:
NUM 34:2 “Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen una enter Kanaan land and evriwhere wey I promise to go give una;
NUM 34:3 den di borda for sout go start from Zin Wildaness go rish di borda for Edom. Una sout borda go face east go rish di Salt Sea.
NUM 34:4 Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon,
NUM 34:5 where e go for turn face di valley wey dey Egypt borda and Mediterranean Sea.
NUM 34:6 “ ‘Di borda for west go bi di Mediterranean Sea.
NUM 34:7 “ ‘Dis go bi una borda for nort: Una go draw line from Mediterranean Sea go Mount Hor
NUM 34:8 and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad.
NUM 34:9 Di borda go kontinue rish Zifron kon end for Hazar-Enan. Dis go bi una nort borda.
NUM 34:10 “ ‘For di borda for east: Una go draw line from Hazar-Enan go Shefam.
NUM 34:11 Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea.
NUM 34:12 Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.”
NUM 34:13 So Moses tell Israel pipol, “Dis na di land wey una go get thru dice wey dem trow. God don give di land to di nine and half tribes.
NUM 34:14 Bikos Reuben, Gad and half for Manasseh tribe wey kom from east, don get dia propaty
NUM 34:15 for di east side for Jordan River near Jeriko.”
NUM 34:16 God tell Moses,
NUM 34:17 “Eleazar di priest and Joshua wey Nun born go divide di land for di pipol.
NUM 34:18 So make yu take one leader from each tribe, so dat dem go help divide am too.
NUM 34:19 Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
NUM 34:20 from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born;
NUM 34:21 from Benjamin tribe, e pick Elidad wey Kislon born;
NUM 34:22 from Dan tribe, e pick Bukki wey Jogli born;
NUM 34:23 from Josef tribe, e pick Hanniel wey Efod born and na leader for Manasseh tribe;
NUM 34:24 from Efraim tribe, e pick Kemuel wey Shiftan born;
NUM 34:25 from Zebulun tribe, e pick Elizafan wey Parnak born;
NUM 34:26 from Issakar tribe, e pick Paltiel wey Azzan born;
NUM 34:27 from Asher tribe, e pick Ahihud wey Shelomi born;
NUM 34:28 from Naftali tribe, e pick Pedahel wey Ammihud born.”
NUM 34:29 Dis na di ones wey God kommand to divide di propaty among Israel pipol wey dey Kanaan land.
NUM 35:1 Den God tell Moses for Moab opposite Jordan River near Jeriko:
NUM 35:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘From among una propaty, make una give Levi pipol di towns wey dem go stay. Una must give Levi pipol land wey get grass near di towns.
NUM 35:3 So dat dem go get town wey dem go stay and dia grassland go bi for dia kattle and all dia animals.’
NUM 35:4 “Di grassland wey dey near di town wey una go give Levi pipol go long rish five hundred yard from di wall for di town.
NUM 35:5 Una must measure 1,000 yard from outside di wall for di town wey dey di east kon measure 1,000 yard from di sout-side and 1,000 yard from di west; di nort go bi 1,000 yard and all di towns go dey di middle. Dis aria must bi dia grassland for di town.
NUM 35:6 “Naw, from dis towns wey una give Levi pipol, una must choose six towns wey dey save wey pesin wey kill somebody go fit hide put. And una must give dem anoda forty-two towns
NUM 35:7 with dia grassland. So di whole land go bi forty-eight.
NUM 35:8 Dis towns must bi Israel pipol own. Di tribes wey big go give more land to Levi pipol, while di small tribes go give small land to Levi pipol. Each tribe go give Levi pipol akordin to di propaty wey dem get.”
NUM 35:9 God tell Moses:
NUM 35:10 “Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen dem don cross Jordan River enter Kanaan land,
NUM 35:11 dem go choose save towns wey pesin wey kill somebody by mistake go fit run go hide.
NUM 35:12 E go dey save for der from di family wey e kill dia pikin. Anybody wey kill pesin, dem must hear from am first before una go kill-am.
NUM 35:13 Make una choose six towns,
NUM 35:14 three for Jordan River east and three for Kanaan land.
NUM 35:15 Dis towns go dey save for Israel pipol and for di strenjas wey dey stay with una for naw or forever. Anybody wey kill pesin by mistake go fit run go hide for one of dis towns.
NUM 35:16 “ ‘But if e use iron take nak pesin die, e must die too, bikos e kill pesin.
NUM 35:17 If na big stone e take kill di pesin, e must die too, bikos e kill pesin.
NUM 35:18 Or if na wood e take kill di pesin, e must die, bikos e kill pesin.
NUM 35:19 Di pesin wey dem kill, en family memba go take revensh. Anytime wey e si di pesin wey kill en broda, e fit kill-am.
NUM 35:20 If anybody hate somebody kon push di pesin or use sometin take stone di pesin die
NUM 35:21 or e nak di pesin die, e must die too, bikos e kill pesin. Di family memba go take revensh. Anytime wey dem si di pesin wey kill dia broda, dem go kill-am too.
NUM 35:22 “ ‘But if na by mistake pesin take kill somebody, weda e push or stone am
NUM 35:23 or nak who nor bi en enemy by mistake,
NUM 35:24 for dis kind kase, di kommunity go judge between di pesin wey kill and di one wey won revensh.
NUM 35:25 Di kommunity go protet di pesin wey kill from doz wey won kill-am and dem must allow am go di save town until di High Priest don die.
NUM 35:26 “ ‘If di pesin wey kill pesin komot from di save town wey e hide put
NUM 35:27 and if dem kill-am, den who kill-am nor go dey guilty.
NUM 35:28 Di pesin wey kill pesin must stay for di save town until di High Priest go die, afta dis, e go fit go house back.
NUM 35:29 “ ‘Una and una shidren go obey dis law for anywhere wey una dey.
NUM 35:30 “ ‘Anybody wey dem akuiz sey e kill pesin go dey guilty, dem go fit kill-am, if two or more pipol bear witness sey na true. But if na only one pesin tok against am, den dat one nor rish to kill-am.
NUM 35:31 “ ‘Dem must kill di pesin wey kill anoda pesin; e nor go fit run from wetin e do.
NUM 35:32 “ ‘If somebody go hide for di save town, make una nor allow am pay any money to take go house back, until di High Priest die.
NUM 35:33 “ ‘If una do like dat, una go spoil di land where una dey stay. Di pesin wey kill pesin dey spoil di land and unless dem kill-am, dem nor go fit klean di land where dem for kill pesin.
NUM 35:34 Israel pipol, make una nor spoil di land wey I dey give una, bikos na mi bi God and I dey stay among una.’ ”
NUM 36:1 Doz wey dey lead Ramot tribe, wey Makir born and Manasseh wey Josef born, en grand-shidren kon go meet Moses and di oda leaders
NUM 36:2 sey, “God don kommand una make una trow dice take share di land give Israel pipol. E still kommand una make una give Zelofehad awa broda propaty to en dotas.
NUM 36:3 But make una remember sey, if dem marry from anoda tribe, dia propaty go kon bi dat tribe own and di total propaty wey go kon bi awa own, go kon small.
NUM 36:4 And wen Israel pipol won do dia Jubili, all di propaty wey dem don sell before, dem go give dem to di original owner kon add di propaty join Zelofehad dotas and na di oda tribe go get am. So dia propaty nor go kon join awa tribe propaty.”
NUM 36:5 As God kommand, Moses kon tell Israel pipol sey, “Wetin Manasseh tribe tok, dey rite,
NUM 36:6 so God sey di dotas wey Zelofehad born fit marry anybody wey dem won, but na only from dia own tribe.
NUM 36:7 Like dis, Israel propaty go still dey for dia tribe.
NUM 36:8 Any woman wey dem share propaty rish from Israel tribe, must marry man wey kom from dat tribe. Like dis, all Israel pipol go get dia papa propaty.
NUM 36:9 No propaty go komot from one tribe go anoda tribe. But evry one for di tribe for Israel go get en own propaty.”
NUM 36:10 As God kommand Moses, na so Zelofehad dotas do.
NUM 36:11 Di dotas wey Zelofehad born na: Mahlah, Tirzah, Hoglah, Milka and Noah. All of dem marry dia papa broda shidren.
NUM 36:12 Dem kon marry from Manasseh wey Josef born tribe and dia propaty kon remain for dia papa tribe.
NUM 36:13 Dis na di rule and laws wey God give Israel pipol thru Moses for Moab land opposite Jordan River for Jeriko.
DEU 1:1 Dis na wetin Moses tell Israel pipol for di wildaness for Jordan River near Arabah opposite Suf, between Paran and Tofell, Laban, Hazerot and Dizahab.
DEU 1:2 Na eleven days journey e suppose bi from Horeb to Kadesh Barnea wen dem pass thru Mount Seir.
DEU 1:3 Forty years afta Israel pipol don komot Egypt, for di first day for di elevent mont, Moses kon tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
DEU 1:4 Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.
DEU 1:5 So, wen Israel pipol dey for Moab land wey dey Jordan River, na der Moses for tell dem dis law:
DEU 1:6 Oga God tok to us for Horeb sey, “Una don too tey for dis mountin.
DEU 1:7 So make una get up kon kontinue una journey go Amor kountries for di hill; all di arias wey dey near der, di high lands, di Shefelah, di Negev, all di lowland, Kanaan and Lebanon, still e rish di great River Eufrates.
DEU 1:8 Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”
DEU 1:9 Moses still sey, “For dat time, I sey, ‘Una wahala too mush for only mi.
DEU 1:10 God don make una many well-well like stars for sky!
DEU 1:11 So make God wey bi una grand-grand papa God bless una well-well, just as E promise!
DEU 1:12 But una wahala too mush to bear! How I wont take handle all una wahala and trobols?
DEU 1:13 Make una choose some men from each tribe wey wise, get wisdom and I go make dem una leaders.’
DEU 1:14 “Den una sey, ‘Wetin yu tell us so, dey good well-well.’
DEU 1:15 “So I take di men wey una selet by unasef kon make dem judge and ofisas ova una. Some dey lead 1,000 pipol, some hundred, some fifty, while some na only ten pipol.
DEU 1:16 For dat time, I tell di judge dem sey, ‘Una must listin to una pipol and doz wey bi strenjas, den make una judge well.
DEU 1:17 Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”
DEU 1:18 For dat time, I kommand una about all di tins wey una go do.
DEU 1:19 Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea,
DEU 1:20 I kon sey, “At last wi don rish Amor pipol kountry wey di Oga awa God don give us.
DEU 1:21 Si! E don put di land for una front. So make una go take am, just as God promise una. Make una nor fear anytin! Make una heart strong!
DEU 1:22 “So all of una waka kom meet mi sey, ‘Make wi first send some men go si di land, so dat dem go kom back kon tell us as e bi. Dem go tell us di best way or town wey wi go take enter and attack di kountry.’
DEU 1:23 “I tink sey wetin una tok dey good, so I kon choose twelf men, one form each tribes.
DEU 1:24 Dem go di hill kountry until dem rish Eshkol Valley kon look am well-well.
DEU 1:25 Dem pick some fruits for der kon meet us. Dem sey, ‘Di land wey awa Oga God don give us, good well-well.’ ”
DEU 1:26 Una nor ready to go, instead una kon dey tok against di Oga awa God kommand.
DEU 1:27 Una dey komplain for korna sey, “Na bikos God hate us na-im make am take us komot Egypt, so dat Amor pipol go distroy us!
DEU 1:28 Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”
DEU 1:29 So I ansa una sey, “Make una nor fear dem at-all!
DEU 1:30 Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt
DEU 1:31 and for di wildaness where E for karry us like man wey dey karry en pikin. Na like dis E dey do for evriwhere wey una go until una rish dis place.”
DEU 1:32 But even afta evritin wey E do, una nor gri trust di Oga wey bi una God,
DEU 1:33 di Pesin wey dey always go find betta place for una, even before una rish der. E dey appear to una thru fire for nite and inside kloud for day time, so dat E go show una di way wey una go-go.
DEU 1:34 Wen God hear as una dey komplain, E vex well-well kon swear sey:
DEU 1:35 “Nobody for dis una wiked generashon nor go si or enter di good land wey I promise una grand-grand papa dem!
DEU 1:36 Di only pesin wey I go allow na Kaleb, Jefunneh pikin wey follow di odas go shek di land and na wetin God wont make e do, na-im e do. I go give en and en shidren-shidren some part for di land wey e bin go look.”
DEU 1:37 And God sef still vex for mi, bikos of una. E tell mi sey, “Even yu, Moses nor go enter di land wey I promise una!
DEU 1:38 But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land.
DEU 1:39 Una shidren wey una feel sey go die for road, di ones wey nor know good from bad, na dem I go give di land to. I go give dem di land and e go bi dia own forever.
DEU 1:40 But una go turn back go di wildaness towards di Red Sea.”
DEU 1:41 Den una ansa mi, “Wi don really sin against God. Naw, wi dey ready to fight doz pipol, just as awa Oga God don kommand.” So each of una wear una war klot kon ready to go fight.
DEU 1:42 But God tell mi, “Make yu tell di pipol sey, ‘Make una nor go fight, bikos I nor go dey with una and una enemies go kill una well-well.’ ”
DEU 1:43 I tell una, but una nor gri listin. Instead una go against God kommand kon go fight.
DEU 1:44 Amor pipol wey dey stay dat aria kom fight and porshu una, just as wiked bee dey do and dem kill una from Seir go rish Hormah.
DEU 1:45 Den wen una kom back, una kom dey kry for God present, but God nor listin to una at-all.
DEU 1:46 Bikos of dis, una kon stay for Kadesh tey well-well.
DEU 2:1 Den wi turn kon travel pass di wildaness go di Red Sea, just as God kommand mi and wi kon dey waka anyhow round Mount Seir for many days.
DEU 2:2 At last, God kon tell mi,
DEU 2:3 “Una don too waka round dis mountin, so make una turn face nort.
DEU 2:4 Make yu give dis kommand to di pipol: ‘Una go soon cross una pipol Edom kountry, wey una broda Esau bi dia grand-grand papa and dem dey stay for Seir. Edom pipol go dey fear una so make una dey kareful.
DEU 2:5 Make una nor borda dem at-all, bikos I nor go give una any of dia land, bikos na di whole Mount Seir land I give Esau dia grand-grand papa.
DEU 2:6 Una fit buy food chop from dem and wota to drink from dem too.
DEU 2:7 “ ‘Di Oga wey bi una God don bless una for evritin wey una dey do. Evry step wey una take for di great wildaness, I dey with una. For dis forty years wey una dey dis wildaness, God dey with una and una get evritin.’ ”
DEU 2:8 So wi nor kon follow Edom, Esau pipol kountry wey dey for Mount Seir. Wi nor pass thru Arabah Valley wey kom from Elat and Ezion-Geber, but wi travel pass Moab dirty land.
DEU 2:9 Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
DEU 2:10 “(Emim pipol dey stay der before; pipol wey get betta pawa many well-well for der and dem tall like Anak pipol.
DEU 2:11 Na Refah and Anak dem still dey koll dis pipol; but Moab pipol dey koll dem Emim.
DEU 2:12 Before-before, na Hor pipol dey stay for Seir, but Esau shidren-shidren drive and distroy dem, den kon stay der, just as Israel pipol do to di land wey dem take and na God give dem dis land.)”
DEU 2:13 God sey, “Naw, make una cross go River Zered.” So wi kon do as E tok.
DEU 2:14 Na thirty-eight years e take us to cross from Kadesh Barnea go River Zered and dat time, all di sojas for dat generashon die finish, just as God tell dem.
DEU 2:15 True-true, na God kill all of dem finish with en own hand for di kamp.
DEU 2:16 So wen all di sojas don die finish among di pipol,
DEU 2:17 God kon tell mi,
DEU 2:18 “Today, una go cross pass Moab pipol borda wey bi Ar land.
DEU 2:19 But wen una don near Ammon pipol, make una nor let dem vex won kon fight una, bikos I nor go give una any of dia land; bikos I don already gi-am to Lot shidren-shidren.
DEU 2:20 “(Before-before, dem sey na Refah pipol dey stay der. Na Refah pipol really dey stay der; Ammon pipol dey koll dem Zamzum.
DEU 2:21 Dem strong; many well-well and dem tall like Anak pipol. But God distroy Refah pipol, bikos of Ammon pipol, so dat dem go fit stay for der.
DEU 2:22 Dis na wetin E do for Esau shidren-shidren for Seir, wen E distroy Hor pipol, so dat dem go fit stay for der till today.
DEU 2:23 But for Avvim pipol wey kom form Krete and dey stay di west side for Gaza and Kaftor pipol aria, make una distroy and take dia land.)
DEU 2:24 “So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am!
DEU 2:25 From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”
DEU 2:26 So I send messenja from Kedemot wildaness go meet King Sihon for Heshbon with peace sey:
DEU 2:27 “Make wi pass thru yor land and wi nor go tosh or take anytin from am; wi nor go even turn rite or left.
DEU 2:28 Yu go sell food and wota give us, so dat wi go chop and drink. Make yu just allow us waka pass,
DEU 2:29 just as Esau shidren-shidren wey dey stay Seir and Moab pipol wey dey stay for Ar allow us pass. Make wi just pass until wi go cross Jordan River go rish di land wey di Oga awa God dey give us.”
DEU 2:30 But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.
DEU 2:31 God tell mi sey, “Si! I don already give una King Sihon and en land. So make una take di land as una own.”
DEU 2:32 Wen King Sihon and all en sojas gada kon fight us for Jahaz,
DEU 2:33 di Oga awa God put dem for awa hand and wi kill dem, plus dia sons and evry oda pesin.
DEU 2:34 For dat time, wi take all di towns kon judge di pipol as God wont am, plus di wimen and shidren, den wi kon kill all of dem.
DEU 2:35 But wi keep di animals for awasef.
DEU 2:36 From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.
DEU 2:37 Aldo wi nor go Ammon pipol land, River Jabbok, di town for di hill or any place wey God sey make wi nor go.
DEU 3:1 Den wi turn kon dey go Bashan and King Og for Bashan kon gada en sojas kom fight us for Edrei.
DEU 3:2 But God tell mi, “Make una nor fear, bikos I don give una viktory ova King Og and all en sojas and I go give una all en land. Make una do to am, just as una do to King Sihon for Heshbon town inside Amor.”
DEU 3:3 So God make us win King Og for Bashan and all en sojas, den wi kill dem finish.
DEU 3:4 For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom.
DEU 3:5 Dem guide all dis towns with high walls, big gates kon lock dem with betta iron key and dem still get many village.
DEU 3:6 Wi judge dem well, both wimen and shidren, just as wi judge King Sihon for Heshbon.
DEU 3:7 But wi keep all di animal and evry oda tin wey wi karry from di town.
DEU 3:8 So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon
DEU 3:9 (Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir),
DEU 3:10 all di towns wey dey di high lands, all di lands for Gilead and Bashan go rish Salekah and Edrei, di towns wey bi King Og for Bashan, own.
DEU 3:11 For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)
DEU 3:12 Dis na di land wey wi kollect den: Di aria from Aroer go River Arnon and half for Gilead hill kountries with dia towns, I give dem to Reuben and Gad tribe.
DEU 3:13 Di remainin one for Gilead and di land for Bashan and King Og kingdom, I give dem to half for Manasseh tribe. (All di aria for Argob, dat is, all Bashan wey dem dey koll Refah land.
DEU 3:14 Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.)
DEU 3:15 I give Gilead to Makir.
DEU 3:16 Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe.
DEU 3:17 Arabah and Jordan River na still borda for Kinneret Sea go rish Arabah Sea (dat is, di Salt Sea), under di low land for Pisgah go rish di east.
DEU 3:18 For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.
DEU 3:19 But una wifes, shidren and animals (Bikos I know sey dem many), make dem stay for di towns wey I give una.
DEU 3:20 Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”
DEU 3:21 I still kommand Joshua sey, “Yu don si evritin wey di Oga yor God do to doz two kings; E go still do di same tin to all di kingdoms wey yu go-go.
DEU 3:22 So make una nor fear, bikos di Oga una God go fight for una by ensef.”
DEU 3:23 So for dat time, I beg God,
DEU 3:24 “My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)
DEU 3:25 Abeg make Yu let mi cross with Israel pipol, so dat I go si di land wey Yu promise awa grand-grand papa dem for di oda side for Jordan River, wey get betta kountries for di hill and Lebanon!”
DEU 3:26 But God vex for mi, bikos of una and E nor gri listin to mi. Instead, E tell mi, “E don do! Make yu nor tok to mi about dat matter again!
DEU 3:27 But klimb go Pisgah and make yu look di east, nort, sout and west well-well, bikos I nor go let yu cross Jordan River.
DEU 3:28 But yu go make Joshua di leader kon enkourage am, bikos na-im go take dis pipol cross kon make dem get di land wey yu go si.”
DEU 3:29 So wi stay for Bet-Peor Valley.
DEU 4:1 Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.
DEU 4:2 Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una.
DEU 4:3 All of una si wetin God do for Baal-Peor. How E distroy di pipol wey serve juju for der.
DEU 4:4 But all of una wey dey faithful to God still dey alive till today.
DEU 4:5 Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.
DEU 4:6 So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.”
DEU 4:7 In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.
DEU 4:8 Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?
DEU 4:9 But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.
DEU 4:10 Make una nor forget di day wey una stand before di Oga una God for Mount Horeb where E for tell mi sey, “Gada all di pipol kom meet mi, so dat I go tell dem my kommand. Den dem go learn to dey fear mi as long as dem dey alive and dem go tish dia shidren to dey fear mi too.”
DEU 4:11 Una waka kom stand near di mountin as di smoke from di mountin dey shot enter sky, but di mountin dark, bikos of di tick kloud.
DEU 4:12 Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin.
DEU 4:13 E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.
DEU 4:14 Na den God kommand mi sey, make I tish una dis rules and law, so dat una go obey dem for di land wey una won enter go stay.
DEU 4:15 But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.
DEU 4:16 I dey tok like dis, so dat una nor go make juju kon kause wahala for unasef. Dis mean sey weda di juju bi like man or woman,
DEU 4:17 any animal, bird wey dey fly,
DEU 4:18 anytin wey dey crawl for groun or any fish for wota.
DEU 4:19 Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart.
DEU 4:20 Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.
DEU 4:21 But God dey vex for mi, bikos of una and E swear sey I nor go ever cross Jordan River or enter di good land wey E go soon give us.
DEU 4:22 So I must die for dis land; I nor go cross Jordan River. But una go cross ova kon take di land wey God promise us.
DEU 4:23 So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.
DEU 4:24 Di Oga una God na strong fire wey dey burn anytin and E dey jealous well-well.
DEU 4:25 Afta una don born shidren and grand-shidren and una don tey for di land well-well, if una spoil unasef kon make juju and do yeye tins wey go make una Oga God vex,
DEU 4:26 I koll heaven and eart as witness today against una. If una break di kommand wey God give una thru mi, una go die for di land wey una won cross Jordan River enter. Una go stay der small; den God go distroy una finish.
DEU 4:27 God go skata una among di pipol and una nor go many for di kountries wey God go drive una go.
DEU 4:28 For der, una go woship gods wey pesin take hand make; wood and stones wey nor go ever fit si, hear, chop or smell.
DEU 4:29 But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.
DEU 4:30 For dat time, wen una dey trobol and all dis tins don happen to una, una go turn kom meet di Oga una God kon obey all en kommand
DEU 4:31 (bikos E dey sorry for pipol), E nor go let una fall or distroy una, bikos E nor fit forget di kovenant wey E make with una grand-grand papa dem.
DEU 4:32 True-true, make una look as e bi before, from di time wey God kreate pipol for dis eart kon rish naw and una look from where di heaven start go rish di end, anytin wey dey great like dis don ever happen or sey pipol si am before?
DEU 4:33 Any kountry don ever hear God vois dey tok to dem from inside fire as una hear kon survive to tell pipol about am?
DEU 4:34 Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?
DEU 4:35 E show una dis tins, so dat una go know sey na di Oga God bi God and no oda pesin or tin, big rish am.
DEU 4:36 E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.
DEU 4:37 Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do.
DEU 4:38 E porshu kountries wey strong pass una komot from dia land, so dat una go fit take di land kon stay der forever.
DEU 4:39 So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey.
DEU 4:40 If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
DEU 4:41 Den Moses selet three town for Jordan River east.
DEU 4:42 Anybody wey by mistake kill pesin wen e bi sey dem nor get wahala or kworel before, fit run go one for dis towns and e go dey save.
DEU 4:43 Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.
DEU 4:44 Dis na di law wey Moses give Israel pipol.
DEU 4:45 All dis na di law, rules and kommand wey Moses tell Israel pipol afta e don lead dem komot from Egypt
DEU 4:46 and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.
DEU 4:47 Israel pipol take di land and King Og for Bashan own too and na di two kings for Amor get am.
DEU 4:48 So Israel pipol take all di aria wey dey for Aroer near Arnon Gorge go rish Mount Sion, wey dem still dey koll Mount Hermon.
DEU 4:49 Israel pipol still win all di wotaside for Jordan River east go rish di sout for di Deat Sea, under Pisgah aria.)
DEU 5:1 Den Moses koll Israel pipol kon sey: “Make una listin well-well to all di law and rules wey I dey give una today, so dat una go learn and obey dem!
DEU 5:2 Di Oga awa God make kovenant with us for Mount Sinai.
DEU 5:3 E nor make dis kovenant with awa grand-grand papa dem, but na with all of us wey dey alive today.
DEU 5:4 God tok to us face-to-face for di mountin from inside fire.
DEU 5:5 (Dat time I stand between God and una, so dat I go tell una God message, bikos una dey fear di fire, so una nor fit klimb di mountin.)”
DEU 5:6 God sey, “Na mi bi di Oga wey bi una God, di One wey take una komot from Egypt where una for bi slave.
DEU 5:7 Make una nor serve any oda god escept mi.
DEU 5:8 Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.
DEU 5:9 Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,
DEU 5:10 but I go show my mesi thru di kovenant to doz wey choose, obey and keep my kommand.
DEU 5:11 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.
DEU 5:12 Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una.
DEU 5:13 Una fit work and do evritin wey una won do for six days,
DEU 5:14 but for di sevent day, una must nor do any work. Dis mean sey, both unasef, una shidren, una savants, una animals or di strenjas wey dey with una, evribody must rest for dat day.
DEU 5:15 Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.
DEU 5:16 Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
DEU 5:17 Make una nor kill.
DEU 5:18 Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
DEU 5:19 Make una nor tif.
DEU 5:20 Make una nor lie for pesin head.
DEU 5:21 Make una nor dey like anoda pesin wife or husband, or sey yu like to take pesin house, land, savants, animal or any oda tin.”
DEU 5:22 God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.
DEU 5:23 But wen una hear en vois from di tick darkness as di mountin dey katch fire, all di eldas and leaders for una tribes kom meet mi.
DEU 5:24 Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive.
DEU 5:25 But naw, why wi go won die again? Bikos if di Oga awa God tok to us again, den wi go really die! If wi kontinue to dey hear awa Oga God vois, wi go die!
DEU 5:26 E get anybody for dis whole world wey hear God vois from inside fire as wi hear am kon still dey alive like us?
DEU 5:27 Make una go by unasef kon listin to wetin God dey tok. Den make una kon tell us evritin wey E tell una and wi go listin and obey.”
DEU 5:28 Wen God hear una dey tok to mi, E kon tell mi sey, “I hear wetin di pipol tell yu and dem tok well.
DEU 5:29 If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.
DEU 5:30 “So make yu go tell dem, ‘Make dem go back to dia house!’
DEU 5:31 But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”
DEU 5:32 So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!
DEU 5:33 Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.
DEU 6:1 Dis na di kommandment, statutes and ordinances wey Oga God give mi make I tish una and una must obey and do dem for di land where una dey go.
DEU 6:2 Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life.
DEU 6:3 Make una pay attenshon, Israel pipol, and dey kareful to do dis, so dat una go stay well kon plenty more-more – as God, una papa-papa Oga tell una and una go inherit di land where milk and honey plenty well-well.
DEU 6:4 Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one!
DEU 6:5 So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.
DEU 6:6 Dis word wey I dey kommand una about today so, una must keep am for una mind
DEU 6:7 and una must tish una shidren kon tok about am as una sidan for house; dey waka for road; dey sleep or wen una wake-up.
DEU 6:8 Make una tie dem for una hand kon wear dem for una fore head, so dat una go dey remember dem.
DEU 6:9 Make una write dem for una gate and door-mot.
DEU 6:10 Den wen di Oga una God take una enter di land wey E promise una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob sey E go give una; di land wey get big and fine-fine towns wey una nor build at-all
DEU 6:11 and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant,
DEU 6:12 so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.
DEU 6:13 Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.
DEU 6:14 Una must nor woship any of una neighbour gods apart from God ensef,
DEU 6:15 bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.
DEU 6:16 Make una nor test di Oga una God, just as una do wen una dey for Massah.
DEU 6:17 Make una make sure sey una dey obey dis kommand well kon keep all di laws wey E give una.
DEU 6:18 Make una always dey do wetin dey rite and good for God eye, so dat evritin go dey well with una, den una go enter and stay for di good land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
DEU 6:19 Just as God sey make una do, all di enemies wey dey stay der, una go porshu dem komot.
DEU 6:20 Tumoro wen una shidren go ask una sey, “Dis law, kommand and rules wey di Oga awa God give us, wetin dem mean?”
DEU 6:21 Den una go tell dem, “Wi bin dey Egypt as Fero slaves, but God take us komot from Egypt with en own strong hand.
DEU 6:22 God do many mirakle, signs and wonders for awa front, bikos E kause betta wahala for Egypt, Fero and en pipol.
DEU 6:23 E take us komot from Egypt, so dat E go give us dis land wey E don promise awa grand-grand papa.
DEU 6:24 Na di Oga awa God kommand us to obey and fear all en kommand, so dat E go kontinue to bless and guide awa life, as E dey do since kon rish today.
DEU 6:25 Wi go dey good for en eye if wi obey all dis kommand wey di Oga awa God give us.”
DEU 7:1 Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)
DEU 7:2 Wen di Oga una God don give dis kountry to una and una don konker dem, una must distroy dem finish. Make una nor enter agriment with dem.
DEU 7:3 Make una nor even marry from dem. Make una nor let una pikin marry dia pikin,
DEU 7:4 bikos dem go take una shidren from mi kon let dem go woship anoda god. Den God go vex for una well-well kon kwik distroy una.
DEU 7:5 Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju.
DEU 7:6 Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.
DEU 7:7 God nor choose una from en heart, bikos una plenty pass oda kountries or small pass oda kountries!
DEU 7:8 But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.
DEU 7:9 So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.
DEU 7:10 But E nor dey waste time to ponish and distroy doz wey rijet am.
DEU 7:11 So una must obey all dis kommand, law and rules wey I dey give una today.
DEU 7:12 If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.
DEU 7:13 E go love and bless una kon make una plenty and E go give una many shidren. E go bless evritin wey una plant and una animals. Wen una rish di land wey E promise sey E go give una grand-grand papa, una go harvest many korn, new wine, olive oil and many kattle, sheep and goats.
DEU 7:14 For all di kountries for di eart, na una God go bless pass. Evry man and woman among una go get shidren and una animals go dey born too.
DEU 7:15 God go protet una from any kind sickness. E nor go let una sofa from di bad-bad diziz wey una si for Egypt, but E go make una enemies sofa dis diziz!
DEU 7:16 All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.
DEU 7:17 Una fit tink and ask, “Dis kountries many pass us, so how wi go take distroy dem?”
DEU 7:18 Make una nor fear. Make una remember wetin di Oga una God do to Fero and Egypt pipol;
DEU 7:19 di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear.
DEU 7:20 Den di Oga una God go send fear go porshu doz wey neva die wey dey hide and E go do am until di very last one wey dey hide from una, go die!
DEU 7:21 So make una nor fear doz kountries, bikos di Oga una God dey with una and E bi God wey dey great and wonderful.
DEU 7:22 Di Oga una God go-go for una front and na small-small E go take porshu doz pipol komot di land for una, until dem go finish. E nor go porshu all of dem at wons, if not wild animals go kon too kwik plenty for di land before una rish der.
DEU 7:23 Di Oga una God go give dem to una; E go make dem fear well-well until una go distroy dem finish.
DEU 7:24 E go put dia kings for una hand and una go remove dia names from dis eart. Nobody go fit fight una and una go distroy all of dem.
DEU 7:25 Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.
DEU 7:26 Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.
DEU 8:1 Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
DEU 8:2 Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.
DEU 8:3 True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok.
DEU 8:4 For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all.
DEU 8:5 Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.
DEU 8:6 So make una obey di kommand wey di Oga una God give una kon do as E tok and always dey fear am.
DEU 8:7 Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill.
DEU 8:8 Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey;
DEU 8:9 land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills.
DEU 8:10 Una go chop beleful kon praiz di Oga una God, bikos of di good land wey E give una.
DEU 8:11 Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.
DEU 8:12 Bikos wen una go don get propaty well-well kon build many fine house to stay
DEU 8:13 and get many animals and many silva and gold, plus evry oda tin,
DEU 8:14 make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before.
DEU 8:15 Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon
DEU 8:16 feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.
DEU 8:17 E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.”
DEU 8:18 Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.
DEU 8:19 But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una.
DEU 8:20 Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.
DEU 9:1 Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky!
DEU 9:2 Di pipol strong well-well and dem tall; dem bi Anak shidren-shidren. Una hear wen dem sey, “Na who go fit fight Anak pipol?”
DEU 9:3 But make una undastand today sey, di Oga una God wey dey waka for una front na fire wey dey burn anytin; E go win dem kon make dem bi like mumu for una front. Just as God tell una, na so una go kwik-kwik konker and distroy dem finish.
DEU 9:4 Afta di Oga una God don do all dis tins for una, make una nor tok for una heart sey, “God give us dis land bikos wi good well-well!” Nor bi bikos una good make God give una, but na di wikedness wey dis oda pipol dey do, na-im make God porshu dem komot for una.
DEU 9:5 Una nor dey enter and stay dis land, bikos una dey good or get sense. Di Oga una God go porshu dis pipol komot for una, bikos of di wikedness wey dem dey do and to fulfil di promise wey E make with una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob.
DEU 9:6 So make una undastand naw sey nor bi bikos una good make di Oga una God dey give una dis land, bikos una nor good and una bi sturbon pipol.
DEU 9:7 Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.
DEU 9:8 Even for Mount Sinai, una make God vex well-well sotey E won kon distroy una.
DEU 9:9 Dis tin happen wen I go di mountin go kollect di ten kommandment wey God make for una. I dey der for forty days and forty nite and I nor chop or drink anytin.
DEU 9:10 God give mi two stones and all di kommandment wey E tell una from inside di fire wen una gada go meet am for di mountin, E use en own hand take rite dem put for di stones.
DEU 9:11 Wen di forty days don finish, God give mi di two stones wey E rite di kovenant put.
DEU 9:12 Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!”
DEU 9:13 God still sey, “I don si sey dis pipol sturbon well-well!
DEU 9:14 So make yu leave mi make I distroy all of dem komot from dis eart. Den I go make strong and mighty pipol from yor shidren-shidren.”
DEU 9:15 So I turn komot di mountin as di fire still dey burn and di two kovenant stones dey my hand.
DEU 9:16 Wen I rish where una dey, I si sey una don really sin against di Oga una God and una don make juju for unasef; una don kwik-kwik turn komot from di way wey God kommand una!
DEU 9:17 So I take di two kovenant stones wey di kommandment dey kon skata dem for una front.
DEU 9:18 Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.
DEU 9:19 I dey fear God vexnashon, bikos E sey E go distroy una. But dis time, E still listin to mi again.
DEU 9:20 God vex well-well for Aaron and E won kon distroy am too. But I pray for Aaron and God kon sorry for am.
DEU 9:21 I take una sin; di juju wey una make kon melt and grind am till e bi like san-san. Den I pour am for wota wey dey flow kom from di mountin.
DEU 9:22 And una still make God vex for Taberah, Massah and Kibrot Hattaavah.
DEU 9:23 Den wen E send una from Kadesh Barnea kon sey, “Make una go take di land wey I don give una,” una still sin against di Oga una God, bikos una nor bilive or obey am.
DEU 9:24 Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!
DEU 9:25 I liedan for groun for God present for forty days and forty nite, bikos E sey E go distroy una.
DEU 9:26 I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.
DEU 9:27 Make Yu remember yor savant, Abraham, Isaak and Jakob; den nor look as dis pipol sturbon, wiked and di sins wey dem dey kommit.
DEU 9:28 Bikos if Yu distroy dem, Egypt pipol go sey, ‘God nor fit karry dem go rish di land wey E promise dem and bikos God hate dem well-well, E take dem komot here go kill for di wildaness.’
DEU 9:29 Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”
DEU 10:1 For dat time, God kon tell mi, “Make yu kut two stones like di first ones den kom meet mi for di mountin; make yu still make box with wood for yorsef.
DEU 10:2 Di same word wey dey di stones wey yu break, I go rite dem put for dis ones and yu must put dem for di box.”
DEU 10:3 So I use akasia wood take make box kon kut two stone like di first ones. Den I klimb go di mountin with di two stones for my hand.
DEU 10:4 So di same word wey bi di ten kommandment wey E tell mi for di mountin and from di fire wen una gada go meet am, God kon rite dem put for dis ones as E bin rite am for di first stones.
DEU 10:5 Den I kom down from di mountin kon put di two stones for di box wey I make, just as God kommand mi and di stones still dey der.
DEU 10:6 For dat time, Israel pipol travel from Beerot Bene Jaakan go Mosera. Aaron die for der and dem beri am and en pikin Eleazar kon take-ova as priest.
DEU 10:7 From der, dem travel go Gudgodah kon from der travel go Jotbatah where wota for dey flow.
DEU 10:8 For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today.
DEU 10:9 Dat na why Levi pipol nor get propaty or land among di oda tribes for Israel. Na God ensef bi dia propaty, just as di Oga una God tok.
DEU 10:10 But for mi, I stay for di mountin just as I do for di first time for forty days and forty nite. For dat time, God still listin to mi kon sey E nor go distroy una.
DEU 10:11 Den E tell mi, “Make yu and di pipol start una journey, so dat dem go-go kollect di land wey I promise dia grand-grand papa.”
DEU 10:12 Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.
DEU 10:13 Una must always obey God kommand and law wey I dey give una today, so dat evritin go dey well with una.
DEU 10:14 Di heavens, di heavens wey high pass, plus di eart and evritin wey dey inside am, na God get all of dem.
DEU 10:15 Yet God show en love to una grand-grand papa dem. And E choose una wey bi dia grand-shidren above evry oda pipol, as all of us dey si am today.
DEU 10:16 So make una shange una heart and stop to dey do strong head.
DEU 10:17 Bikos di Oga una God na God of all gods and Oga of all ogas. Na en bi di great Oga God, di God wey dey do wonders, God wey nor dey do wayo and nobody fit bribe am.
DEU 10:18 Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.
DEU 10:19 So una too must show love to strenjas, bikos unasef bi strenja for Egypt before.
DEU 10:20 Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.
DEU 10:21 Na only en bi God; di only one wey wi go dey praiz; di Pesin wey don do many wonderful mirakles wey una don si with una own eyes.
DEU 10:22 Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!
DEU 11:1 Una must love di Oga wey bi una God kon obey evritin wey E tok. Dat is, en law, rules and kommand wey E give una.
DEU 11:2 Make una know for una mind sey, I nor dey tok to una shidren wey neva si as di Oga una God judgement bi or si as E big and strong rish.
DEU 11:3 Dem nor si all di wonderful signs wey E do for una wen una dey serve King Fero and en pipol for Egypt.
DEU 11:4 Dem nor si wetin God do to Egypt sojas and dia shariot. How E take kill dem for di Red Sea wen dem dey porshu una. E distroy dem finish and dem neva fit balance kon rish today!
DEU 11:5 Una shidren nor si wetin God do for una wen una dey di wildaness before una rish here.
DEU 11:6 Dem nor si wetin E do to Datan and Abiram (wey Eliab wey kom from Reuben tribe, bi dia papa) wen groun open for Israel kamp kon swallow dem with dia family, dia house and evritin wey dem get.
DEU 11:7 But I dey tok to una bikos na una si all di wonderful tins wey God do!
DEU 11:8 Naw, make una listin to all en kommand wey I dey give una today, so dat una go strong rish to kollect and enter di land wey una dey go so.
DEU 11:9 If una obey di kommand, una go get long life for di land wey God promise sey, E go give una grand-grand papa and una wey bi dia shidren; land wey milk and honey full!
DEU 11:10 Bikos di land wey una go soon enter go stay, nor bi like Egypt where una from dey kom and where una nid to work with una hand and leg to take plant vegitabol.
DEU 11:11 But di land wey go soon bi una own, na land wey get hills and valleys with plenty rain,
DEU 11:12 di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!
DEU 11:13 Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind,
DEU 11:14 E go send rain for una land for di rite time, both di early and late rain, so dat una go harvest una food, new wine and oil.
DEU 11:15 E go give una animals plenty grass for di land and una go chop beleful.
DEU 11:16 But make una dey kareful. Make una nor let anybody deceive una, so dat una nor go turn from God kon dey serve and woship oda gods.
DEU 11:17 If una do like dis, God go vex for una well-well. E go lock di sky and rain nor go fall, den di groun nor go bear food. Den una go kwik-kwik die for di good land wey God dey give una.
DEU 11:18 So make una keep dis kommand for una mind. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una head, so dat una go remember dem.
DEU 11:19 Make una tish dis kommand to una shidren. Make una tok about dem wen una dey house and wen una dey for road, even wen una won sleep and wen una wake-up.
DEU 11:20 Make una rite dem put for una door-mot and for una gate,
DEU 11:21 so dat as long as di sky dey on-top di eart, una and una shidren go dey betta for di land wey God promise una grand-grand papa.
DEU 11:22 Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do.
DEU 11:23 Den God go drive all di kountries wey dey una front, aldo dem really strong and great pass una, but una go take dia land.
DEU 11:24 Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea.
DEU 11:25 Nobody go fit stop una; di Oga una God go make dem fear una for any land wey una waka enter, just as E promise una.
DEU 11:26 Si, today I dey give una shance to pick between blessing and curse!
DEU 11:27 God go bless una if una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today.
DEU 11:28 But na curse bi una own, if una rijet di Oga una God kommand kon turn from am go woship oda gods wey una nor know before.
DEU 11:29 Wen di Oga una God take una enter di land kon help una stay der, una must tok about di blessing for Mount Gerizim and di curse for Mount Ebal.
DEU 11:30 (Dis two mountins dey di west side for Jordan River where Kanaan pipol for di Valley, dey stay, near Gilgal town wey nor far from Moreh Oak.)
DEU 11:31 Bikos una go soon cross Jordan River go take di land wey God dey give una. Wen una take di land kon dey stay inside,
DEU 11:32 make una dey kareful as una dey obey all di rules and law wey I dey give and tell una today.
DEU 12:1 Dis na di rules and laws wey una must obey, wen una don enter di land wey una grand-grand papa God, dey give una. As long as una dey alive, una must obey dem.
DEU 12:2 Wen una porshu di kountries wey dey der, una must distroy all di place wey dem for dey woship dia gods, both for di mountin, on-top di hill and under evry tree.
DEU 12:3 Make una break di altars and skata di pilas. Make una burn di Asherah juju poles kon kut dia juju. Make una make sure sey una distroy all dia gods!
DEU 12:4 Make una nor woship di Oga una God just as dis pagans dey woship dia gods,
DEU 12:5 but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.
DEU 12:6 For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get.
DEU 12:7 For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.
DEU 12:8 Una nor go woship God as wi dey do for here today, where evribody dey do as dem like,
DEU 12:9 bikos una neva even rish where una dey go kon kollect di land wey di Oga una God dey give una.
DEU 12:10 Wen una don cross Jordan River kon kollect and stay for di land; wen God don give una rest from all una enemies and una dey save for di land,
DEU 12:11 una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.
DEU 12:12 For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).
DEU 12:13 Make una dey kareful, so dat una nor go sakrifice una burnt ofrin for anywhere wey una like.
DEU 12:14 Una go only sakrifice am for di place wey God go choose from among una tribe. Na der una go for offa una burnt ofrin and do evritin wey I kommand una.
DEU 12:15 But una fit kill una animals kon chop en meat for any town wey una wont. Una fit chop di animal wey God give una as una like. All of una, weda una dey klean or not, fit chop meat, just as una dey chop gazelle and deer.
DEU 12:16 But una must nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.
DEU 12:17 But make una nor chop ofrin for una own town or tithe for una harvest and for una first fruit or animal, or sakrifice ofrin and vow ofrin.
DEU 12:18 Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.
DEU 12:19 As long as una dey dis land, make una dey kareful as una dey kare for Levi shidren.
DEU 12:20 Wen di Oga una God don make una land big as E sey E go do and una like to chop meat, una dey free to chop as una like.
DEU 12:21 If di place wey God choose sey una go woship am too far for una, una fit kill any of una animal wey E don give una, just as I kommand una; kon chop dem for una town as una like.
DEU 12:22 Just as una dey chop gazelle or deer; doz wey dey klean and doz wey nor dey klean, fit chop dem too.
DEU 12:23 But make una nor chop blood, bikos blood na life and una must nor chop animal blood with di meat.
DEU 12:24 Instead, make una pour di blood for groun like wota.
DEU 12:25 Make una nor chop di blood, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren and if una do like dat, belle go sweet God.
DEU 12:26 But make una take di holy ofrin and di vow wey una make, go di place where God choose.
DEU 12:27 Di meat and blood from una burnt ofrin, make una put am for di Oga una God altar. Make una pour di oda sakrifice blood for di Oga una God altar, but una fit chop di meat.
DEU 12:28 Make una make sure sey una obey all di kommand wey I dey give una, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren, bikos una do wetin dey good and betta for una Oga God eye.
DEU 12:29 Wen di Oga una God dey go for una front go distroy all di kountries and una drive dem komot kon stay di land,
DEU 12:30 make una nor follow dem serve dia juju and gods. Make una nor ask about dia gods or sey, “Na how dis pipol take dey woship dia gods? Make wi serve God like dem.”
DEU 12:31 Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.
DEU 12:32 So all dis kommand wey I dey give una so, make una obey dem with kare. Make una nor add join or remove from dem.
DEU 13:1 May bi una get profet or doz wey dey si wetin go happen among una and dem kon show una signs and wonders,
DEU 13:2 den wetin dem show una kon happen. If dem sey, “Make una kom make wi woship oda gods; gods wey una neva sey before.”
DEU 13:3 Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart.
DEU 13:4 Una must follow di Oga una God kon woship only en and una must follow en kommandment, obey, serve and always dey loyal to am.
DEU 13:5 But for di profet and doz wey dey si wetin go happen, make una kill dem, bikos dem won make pipol sin against di Oga una God wey take una komot from Egypt where una for bi slave. Una must kill dem, bikos dem dey try to deceive una komot from di way wey God wont make una follow. So like dis, una must skata and distroy evry bad tin or pipol wey dey among una.
DEU 13:6 Weda na una broda, pikin, wife or friend kon tok and wont make una serve oda gods wey una or una grand-grand papa nor know before,
DEU 13:7 or if dem wont make una woship doz oda pipol gods,
DEU 13:8 make una nor do am or listin to dem. Make una nor sorry for dem or protet dem.
DEU 13:9 Una must kill dem! Make una bi di first to attack dem and evry oda pesin go join una.
DEU 13:10 Una must stone dem die, bikos dem try to make una turn from di Oga una God wey diliver una from Egypt, di place where una for bi slave.
DEU 13:11 Den, Israel pipol go hear about am kon fear and nobody go won do wiked tins again.
DEU 13:12 Wen una don start to stay for di land, una fit hear sey,
DEU 13:13 some wiked pipol don leave una go tok to pipol wey dey di land before sey, “Make wi go serve and woship anoda god.” (Gods wey una neva si before.)
DEU 13:14 For dis kind matter, una must look di kase well-well. If una find out sey dis bad tin wey happen, na true,
DEU 13:15 den make una make sure sey una kill all doz wey dey di town; plus all di animals wey dem get.
DEU 13:16 Una must gada all di dirty for der kon put am for di street centre, den burn di town rish groun as ofrin to di Oga una God. Una must distroy di town forever and make nobody build am again.
DEU 13:17 Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.
DEU 13:18 Di Oga una God go sorry for una only if una listin to en vois, keep en kommand wey I tell una kon dey do wetin dey good for en eye.
DEU 14:1 Since una bi Oga God shidren, make una nor ever kut unasef or shave una hair sey una dey kry for who don die.
DEU 14:2 Bikos una dey holy to di Oga una God, na-im make am choose una as en pipol wey E love pass among evry oda tin for dis world.
DEU 14:3 Make una nor chop anytin wey dem dey forbid.
DEU 14:4 Dis na di animals wey una fit chop: melu, sheep, goat,
DEU 14:5 gazelle, deer, wiked goat, antelope, wiked oryx and di sheep for mountin.
DEU 14:6 Una fit chop animals wey dia leg divide into two and dey shew grass,
DEU 14:7 but if di animal nor get am, make una nor chop am. So make una nor chop kamel, hare or hyrax. Dem dey really shew grass, but dia leg nor divide, so dem nor dey klean to chop.
DEU 14:8 Make una nor chop pig. E get strong leg wey divide, but e nor dey shew, so e nor dey klean. Make una nor chop dis animals or even tosh dia dead body.
DEU 14:9 For all di animals wey dey for river, una fit chop anytin wey get both fins and skales.
DEU 14:10 But make una nor chop any animal for wota wey nor get fins and skales, bikos dem nor dey klean.
DEU 14:11 Una fit chop any bird wey dey klean.
DEU 14:12 Di birds wey una nor go chop na: eagle, vulture, black vulture,
DEU 14:13 kite, falkon, any buzzard,
DEU 14:14 any kind raven,
DEU 14:15 ostrich, owl, seagul, any kind hawk,
DEU 14:16 small owl, big owl or barn owl,
DEU 14:17 owl for wildaness, Egypt vulture, kormorant,
DEU 14:18 stork, any kind herons, hoopoe and bat.
DEU 14:19 Any insect wey dey waka for groun with feada nor dey klean for una and make una nor chop dem.
DEU 14:20 But una fit chop any bird and insect wey dey fly, bikos dem dey klean.
DEU 14:21 Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.
DEU 14:22 Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.
DEU 14:23 Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God.
DEU 14:24 Wen E bless una, if di place where E choose sey una go for honor en name dey far,
DEU 14:25 una fit sell all doz tins kon travel with di money wey una sell am go di place wey di Oga una God don choose by ensef.
DEU 14:26 Wen una rish der, una fit use di money take buy any food wey una wont, plus kattle, sheep, goats, wine or beer and anytin wey una like. Den make una do party for di Oga una God present kon celebrate with una family.
DEU 14:27 Make una nor forget Levi pipol wey dey una town, bikos dem nor get land or propaty among una.
DEU 14:28 For di end of evry three years, una go bring all di tithe for dat year harvest kom, den keep am for di town wey dey near where God choose.
DEU 14:29 Make una gi-am to Levi pipol, bikos dem nor get land or propaty among una. Make una still give to di strenjas wey dey stay with una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go chop beleful. Den di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.
DEU 15:1 For di end of evry seven year, make una kancel di debt wey anybody dey owe una.
DEU 15:2 Dis na how una go dey do am. Evribody must kancel di debt wey dia fellow Israel broda dey hold dem. Dem must nor sey make dia neighbour or rilative pay dem back, bikos God time to free pipol, don rish.
DEU 15:3 Dis freedom from debt na for only una brodas nor bi for di strenjas.
DEU 15:4 Make poor pesin nor dey among una, bikos di Oga una God go really bless una for di land wey E dey give una as una own forever.
DEU 15:5 Una go receive dis blessing if una really obey dis kommand wey I dey give una.
DEU 15:6 Bikos di Oga una God go bless una just as E promise; una go give to many kountries, but una nor go borrow from any one. Una go rule many kountries, but no kountry go rule una.
DEU 15:7 But if anybody dey poor for Israel wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor do strong head for am at-all.
DEU 15:8 Una must make sure sey una dey good to am kon gi-am anytin wey e nid.
DEU 15:9 Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.
DEU 15:10 Make una dey give to poor pipol with happiness, bikos di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.
DEU 15:11 E go always get some pipol for di land wey go dey poor. Dat na why I dey kommand una to dey give with happy mind to poor pipol and odas for Israel wey nid anytin.
DEU 15:12 If una fellow Hibru sell ensef to bi una savant kon serve una for six years, for di sevent year, una must free di pesin.
DEU 15:13 Wen una dey free una savant, make una nor let dem go like dat.
DEU 15:14 Make una give dem betta gift with happiness from una animal and from una wine. Make una give some of di blessing wey God give una.
DEU 15:15 Make una remember sey una bi slave for Egypt until di Oga una God kon save una! Na dis make mi dey give una dis kommand.
DEU 15:16 But if una savant sey, “I nor wont go,” bikos e love una and una family and e don serve una well.
DEU 15:17 For dat kind kase, make una take sharp iron take press en ear join di door, den e go bi una savant forever. Una go do like dis both for una man and woman savant.
DEU 15:18 Make una nor si am as big lost wen una free una savants. Make una remember sey, di work wey dem don work for una for six years, if una sey make una hire pesin make e do am, una go pay am times two. So di Oga una God go bless una for dis tin wey una do.
DEU 15:19 All di first male wey una animal born, una go give dem to God. Make una nor use dem take go klear una field and make una nor shear dem at-all.
DEU 15:20 Instead, for evry year, una and una family go chop dem for di Oga una God present, for di place wey E choose.
DEU 15:21 But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.
DEU 15:22 Instead, make una use am take kook for una family for house. Anybody, weda e dey klean or e nor klean, fit chop from am, just as anybody fit chop deer or gazelle.
DEU 15:23 But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.
DEU 16:1 Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.
DEU 16:2 Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name.
DEU 16:3 Make una chop am with bread wey dem nor make with yist and una go chop dis bread for seven days, just as e bi wen una rush dey komot from Egypt. Make una chop dis bread (bikos na-im una chop wen una dey sofa), so dat as long as una dey alive, una go remember di day wey una komot from Egypt.
DEU 16:4 Make dem nor si yist for anybody house for dis land thru-out di seven days. And wen una sakrifice di Passova lamb for evening for di first day, make una nor let any meat remain till morning.
DEU 16:5 Una nor go just sakrifice di Passova lamb for any town wey God dey give una.
DEU 16:6 Una go only sakrifice am for di place wey dem for dey woship God; di place wey di Oga una God choose sey dem go for honor en name. As di sun dey go down, una go sakrifice am der for evening to take celebrate and remember wen una komot from Egypt.
DEU 16:7 Make una roast and chop di lamb for di place wey una Oga God choose. Den, di next day, una fit go back to una house.
DEU 16:8 For di next six days, make una nor chop any bread wey dem make with yist. Una go make di sevent day anoda holy day to honor di Oga una God and make nobody work for dat day.
DEU 16:9 From di day wey una bigin harvest, make una kount seven weeks.
DEU 16:10 Den make una celebrate Harvest Feast to honor di Oga una God. Make una gi-am ofrin from una mind, akordin to how E bless una rish.
DEU 16:11 Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una.
DEU 16:12 Make una remember sey na slave una bi for Egypt before, so make una obey all dis kommand with kare.
DEU 16:13 Make una celebrate Shelta Feast for seven days for di time wen una dey harvest una plant and grapes.
DEU 16:14 Wen una dey celebrate dis feast, make una happy with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die, wey dey stay with una.
DEU 16:15 Una must celebrate dis feast for seven days to honor di Oga una God for di place wey E choose, bikos na en bless una well-well kon make all una work, prosper. Dis feast go bi time for evribody to happy.
DEU 16:16 For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.
DEU 16:17 Evribody must give God as dem fit do rish and na akordin to how di Oga God bless dem rish.
DEU 16:18 For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.
DEU 16:19 Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.
DEU 16:20 Make una judge well, so dat una go stay long for di land wey di Oga una God dey give una.
DEU 16:21 Apart from di altar wey una build for di Oga wey bi una God, make una nor ever use wood take build house for Asherah juju.
DEU 16:22 Make una nor ever build juju house kon woship dem, bikos di Oga una God nor like all dat kind tin.
DEU 17:1 Make una nor sakrifice any animal wey nor well or get problem give di Oga una God, bikos dat kind tin dey make am vex.
DEU 17:2 Wen una don dey stay di town wey di Oga una God go give una, if one man or woman among una do bad tin for God eye kon go against en kovenant,
DEU 17:3 bikos e go serve anoda god or woship di sun, moon, star or di pawas for heaven, tins wey I sey make una nor do,
DEU 17:4 wen una hear about dat kind tin, make una shek di matter well-well. If na true sey dem do dis bad tins for Israel,
DEU 17:5 den make una take di man or woman wey kommit dis sin go outside di town gate kon stone am die.
DEU 17:6 But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.
DEU 17:7 Di pipol wey tok about di tins wey di pesin do, na dem go first stone di pesin, before oda pipol go join dem. Like dis, una go stop wiked and evil tins among una.
DEU 17:8 If matter too strong for una to judge; matter like to kill pesin or matter wey koncern propaty or wahala for village, make una karry doz kind matter go di place wey di Oga una God don choose.
DEU 17:9 Una go-go meet di Levi priest or di judge wey dey on duty. Dem go hear di kase kon give judgement.
DEU 17:10 Una must do as dem judge for di place wey God choose. Una must do just as dem tok.
DEU 17:11 Afta dem don read di law kon pass judgement, una must do anytin wey dem tok; make una nor try to shange wetin dem tok at-all.
DEU 17:12 Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.
DEU 17:13 Den wen all di pipol hear am, dem go fear to do wiked tins.
DEU 17:14 Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una and una don take and dey stay inside, den una sey, “Like all di kountries wey dey around us, na so too wi go selet king for awasef,”
DEU 17:15 Una must selet di king wey di Oga una God go choose. Una go choose king from among unasef. Make una nor choose pesin wey nor kom from Israel.
DEU 17:16 Make di king nor build big house where e go put horse, or make di pipol go back to Egypt go buy horse, bikos God don sey, “Make una nor go back to Egypt.”
DEU 17:17 Make di king nor marry many wife for ensef, bikos dem go turn en heart from di Oga una God. Make e nor gada money, silva or gold for ensef.
DEU 17:18 Wen e sidan for di throne as king, make e kopy dis kommand put for book for di Levi priest present.
DEU 17:19 Make e always keep dat kopy with am evriday as long as e dey alive. Like dat, e go learn how to fear di Oga en God as e dey obey all di laws and kommand.
DEU 17:20 As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.
DEU 18:1 Make una remember sey Levi pesin wey bi priest, plus di whole Levi tribe nor get any propaty or land among di oda tribes for Israel. Instead di priest and Levi pipol go chop from di special gift wey di oda tribes go give God, bikos na dat bi dia share.
DEU 18:2 Dem nor get any land for diasef for Israel. Na God bi dia propaty, just as E don tell dem.
DEU 18:3 Di tins wey di priests go take as dia own share, na di animals and oda tins wey di oda tribes bring kom as ofrin: dem go take di animals shoulder, jaw and belle.
DEU 18:4 Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest.
DEU 18:5 Bikos na di Oga una God choose Levi tribe out of all di tribes wey dey Israel to serve am forever.
DEU 18:6 And if one Levi pesin kom from any town for Israel kon sey e dey go where God don choose sey make dem woship am,
DEU 18:7 e fit serve for der with God name, just like evry oda Levi wey bi priest wey dey serve God for der.
DEU 18:8 Dem go give di same food like di oda priests and e fit keep anytin wey en family send kom gi-am.
DEU 18:9 Wen una enter di land wey di Oga una God dey give una, make una nor learn wetin di oda kountries for der dey do.
DEU 18:10 For ezample, make una nor burn una shidren as sakrifice. And make nobody learn how to dey tell pipol dia future;
DEU 18:11 learn to use juju; how to tok to oda spirit or witch spirit.
DEU 18:12 Anybody wey dey do dis kind tin, dey make God vex. Na bikos of dis tins wey di oda kountries do, na-im make God porshu dem komot from di land for una.
DEU 18:13 But make una serve di Oga una God well-well, so dat E nor go si any fault for una body.
DEU 18:14 Di pipol wey una won porshu dey do dis tins, but di Oga una God dey sey make una nor do dis kind tin.
DEU 18:15 Di Oga una God go raiz profet like mi from among una and e go bi una own kountry man and make una listin to am.
DEU 18:16 Bikos dis na wetin una ask di Oga una God by unasef wen una gada go meet am for Mount Sinai. Una sey, “God, make Yu nor let us hear yor vois again or si di big fire again, bikos wi go die.”
DEU 18:17 God kon tell mi, “Wetin dem tok dey good.
DEU 18:18 From among dia own pipol, I go raiz one profet like yu. I go put my word for en mout and e go tell dem anytin wey I kommand.
DEU 18:19 Anybody wey nor gri listin to wetin di profet tok, na mi go ponish am with my own hand.
DEU 18:20 But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.
DEU 18:21 “But una fit ask unasef, ‘How wi won take know sey, dat message nor bi from God?’
DEU 18:22 Wen any profet dey tok with God name and wetin e tok nor kon happen at-all, una go know sey nor bi God send am, but di profet just dey tok on en own, so make una nor listin, bilive or fear am.”
DEU 19:1 Wen di Oga una God don distroy di pipol wey E won give dia land to una, una go take di land kon stay for dia towns and house.
DEU 19:2 Den for di centre for di land wey God dey give una, make una keep three town for der.
DEU 19:3 For di aria for di land wey God dey give una as una own, una go measure and divide am into three, so dat pesin wey kill anoda pesin fit run go der.
DEU 19:4 If pesin kill anoda pesin by mistake, without sey dem kworel or dey fight before, di pesin fit run go any of di town go stay.
DEU 19:5 For ezample, may bi pesin go forest with en neighbour go kut wood. Den one of dem kon karry di axe make e kut di tree and di axe head komot from di wood wey hold am kon kill di oda pesin. For dis matter, dat pesin wey kill di pesin fit run go one of dis towns and e go dey save.
DEU 19:6 Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin.
DEU 19:7 Na dis make mi sey, make una keep three town wey pesin go run go and e go dey save.
DEU 19:8 And if di Oga una God don make una land big, just as E promise una grand-grand papa kon give una all di land wey E promise dem
DEU 19:9 and una dey obey all di kommand wey I dey give una today (wey bi to love di Oga una God and always do as E tok), dat time, make una add three towns join di first three.
DEU 19:10 Una must nor kill innocent pesin for di land wey di Oga una God won give una, bikos dat go make una dey guilty.
DEU 19:11 But if pesin hate en neighbour kon hide for korna dey wait am, so dat e go attack and kill-am, den run go dis towns,
DEU 19:12 di pesin wey old pass for en family go sey make dem bring am kom, so dat dem go kill-am too.
DEU 19:13 Make una nor sorry for dat kind pesin! Pipol wey dey kill pipol wey nor do anytin, make una komot dem from Israel, den evritin go dey well with una.
DEU 19:14 Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor ever tif anoda pesin land or komot di boundary stone for where una grand-grand papa sey make dem put am.
DEU 19:15 Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.
DEU 19:16 If pesin kom outside kon tok wetin e nor si about anoda pesin,
DEU 19:17 den, both who tok and who dem dey tok about go kom God present kon tok before di priest and di judge wey dey der.
DEU 19:18 Den di judge go handle di matter well-well. If di oda pesin lie for en broda head,
DEU 19:19 den di deat wey e won make e broda die, na en go die-am. Like dis, una go remove all dis bad pipol among una.
DEU 19:20 Den di rest pipol go hear wetin happen and dem go kon dey fear to do doz kind bad tins.
DEU 19:21 Anybody wey dey guilty, make una nor sorry for am! Una matter must bi life-for-life, eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.
DEU 20:1 Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una!
DEU 20:2 Wen una dey ready for war, make di priest kom front kon tok to di sojas.
DEU 20:3 E go tell dem, “Israel men, make una listin to mi! Today, as una dey go fight una enemies, make una nor fear at-all! Make una heart nor fail una or una kon dey shake for dia front like pikin wey nor well.
DEU 20:4 Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”
DEU 20:5 Den di soja oga go tok to di sojas sey, “E get anybody for here wey just build new house and e neva dedikate am? If na so, den yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go dedikate yor house.
DEU 20:6 E get anybody for here wey just plant vineyard and neva chop anytin from am? If na so, yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go chop di first fruit for yor harvest.
DEU 20:7 E get anybody for here wey just engage woman, but e neva marry am? If na so, yu fit go house go marry, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go marry di woman.”
DEU 20:8 Den di soja oga go sey, “E get anybody among us wey dey fear or en heart dey shake? If na so, yu fit go house before yu go make anoda pesin, fear too.”
DEU 20:9 Wen di oga don tok to dia sojas finish, dem go choose pesin wey go dey kommand each group.
DEU 20:10 As una near any town wey una won attack, make una first try to make peace with en pipol.
DEU 20:11 If dem agri with una kon open di gate for una, den all di pipol for dia go serve una as una savants.
DEU 20:12 But if dem nor gri open di gate for una and dem dey ready to fight, una must attack dat town.
DEU 20:13 Wen di Oga una God don give dat town to una, make una use una swod take kill all di men, yong boys or boy pikin for dat town.
DEU 20:14 But una fit take all di wimen, shidren, animals and oda tins wey una fit take. Make una enjoy all di tins wey una take from una enemies land wey God dey give una.
DEU 20:15 But dis kommand na for only di towns wey dey far-far, nor bi for di towns inside di kountries wey una won stay.
DEU 20:16 For doz towns and kountries wey di Oga una God dey give una as where una go stay, make una distroy evritin wey dey inside dem.
DEU 20:17 Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol, una must distroy dem finish, just as di Oga una God kommand.
DEU 20:18 If una distroy dem finish, di pipol for di land nor go dey to tish una how to serve and woship dia own gods and juju wey go make una sin against di Oga una God.
DEU 20:19 Wen una dey attack any town and di war nor dey end, make una nor use una axe take kut di trees. Una fit chop dia fruit, but make una nor kut dem. Na di trees bi una enemies wey make una won attack dem?
DEU 20:20 Di only tree wey una fit kut, na di ones wey nor good for food, den kon use dem take make tins wey una nid to take attack di enemies town until di town go fall.
DEU 21:1 Wen una dey di land wey di Oga una God dey give una, una fit si pesin wey dem kill for di field and una nor know who kill-am.
DEU 21:2 For dat kind matter, una eldas and judge go measure from where dem for kill di pesin go rish di town wey dey near der.
DEU 21:3 Di eldas for di town wey dey near where dem for kill di pesin, go take one small melu wey dem neva tish anytin or use work at-all.
DEU 21:4 Dem go escort am go di valley wey dem neva plant or klear before and wey wota dey rush pass. Wen dem rish di valley, dem go break di melu neck for der.
DEU 21:5 Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town.
DEU 21:6 Di eldas for dat town must wosh dia hand on-top di small melu wey dem don break en neck.
DEU 21:7 Den dem go sey, “Awa hand and leg nor dey for dis pesin deat and wi nor si am wen dem dey kill-am.
DEU 21:8 So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all.
DEU 21:9 If una follow dis kommand, una go do wetin dey rite for God eye and una go dey save from dis sin.
DEU 21:10 Wen una dey go fight una enemies and di Oga una God make una win kon katch some of dem as una prisona
DEU 21:11 and among di pipol wey una take so, una si fine woman for inside wey una like marry,
DEU 21:12 una fit karry am go una house. Di woman must shave en head, kut en finger
DEU 21:13 burn di klot wey e wear wen dem katch am, den kon stay una house. E go take one mont take mourn for en papa and mama wey die. Den una fit marry am as una wife.
DEU 21:14 But if una marry am and e nor dey do as una wont make e do, make una let am go free. Since una force and sleep with di woman, una nor go fit trit am like slave kon sell am.
DEU 21:15 If man get two wife and e love won pass di oda, den di two wife born boy pikin, If di first-born na from di wife wey e nor love,
DEU 21:16 wen di man dey divide en propaty, make e nor give di biggest part to di yonga one wey e love en mama, bikos nor bi en dem first-born.
DEU 21:17 E must give di first pikin wetin bi en own, even doh e nor love di mama. E must gi-am times two of wetin e give di sekond pikin, bikos na di first son bi en papa pawa and honor.
DEU 21:18 If pesin get sturbon son wey nor dey listin to en papa and mama even doh dem ponish am,
DEU 21:19 make en papa and mama seize am kom meet di eldas for di town gate.
DEU 21:20 Dem go tell di eldas for di town sey, “Awa pikin too sturbon and e nor dey hear word, e dey chop and drink anyhow.”
DEU 21:21 Den, all di men for di town go stone di pikin die. Like dis, una go remove all di wiked pipol wey dey among una and wen evribody for Israel hear wetin happen, fear go katch dem.
DEU 21:22 If pesin do wetin go make dem kill-am and dem hang am for tree make e die,
DEU 21:23 make di body nor dey di tree till di next day. Na dat same day una go beri di body, bikos en body wey dem hang, na curse for God eye. Make una nor dirty di land wey di Oga una God dey give una.
DEU 22:1 Wen una si una neighbour animal dey waka lost, make una nor trowey una eye; una must riton am go give di owner.
DEU 22:2 If di owner nor dey stay near una or una nor know who e bi, make una take am go una house until di owner go kom find am, den una must gi-am back en animal.
DEU 22:3 Na di same tin una go do to donkey, klot or any oda tin wey una neighbour lost wey una si. Make una dey ready to always help una neighbour.
DEU 22:4 Wen una si una neighbour donkey or melu dey faint for road, make una nor trowey una eye or waka pass am; instead make una make sure sey una help di animal.
DEU 22:5 Make woman nor wear klot wey bi man own and make man nor wear woman klot, bikos anybody wey dey do dis kind tin, dey make di Oga una God vex.
DEU 22:6 If una si bird house for tree or for groun and yong birds or eggs dey inside with dia mama for der, make una nor take di mama from en shidren.
DEU 22:7 Make una free di mama, but una fit take di shidren. Make una do like dis, so dat e go dey well with una and una go get long life.
DEU 22:8 If una build new house, make una build guide round di roof, so dat dem nor go sey una kill pesin in kase pesin fall from di top.
DEU 22:9 Make una nor plant two difren seed for una vineyard; if not, all di fruit and di seed wey una plant, go skata.
DEU 22:10 Make una nor klear una farm with donkey and melu togeda.
DEU 22:11 Make una nor wear klot wey dem use wool and linen take make.
DEU 22:12 Una must fold una kover klot for di four korna.
DEU 22:13 If anybody marry woman kon sleep with am den
DEU 22:14 e porshu am for publik kon sey, “Na wen I marry dis woman, I know sey e nor bi virgin.”
DEU 22:15 Den di woman papa and mama must bring proof kon give di eldas for di town gate sey, dia pikin na virgin.
DEU 22:16 Di girl papa go tell dem, “I give my pikin to dis man as en wife and naw, e don rijet am.
DEU 22:17 E dey curse di girl sey, ‘I don know sey yu nor bi virgin.’ But dis klot show sey my pikin na virgin, before e marry am.” Den, dem go spread di girl bed shit for di eldas front.
DEU 22:18 Di eldas go take di man kon ponish am.
DEU 22:19 Dem go still tell am make e pay 100 silva to di woman papa, bikos na for publik e for curse di woman sey e nor bi virgin. Den di woman go still bi di man wife and e nor go fit sey make di woman pak komot from en house.
DEU 22:20 But if wetin di man tok na true and e show sey di woman nor bi virgin,
DEU 22:21 den dem go take di woman go en papa door-mot. For der, di men for di town go stone am die. E don kommit bad sin for Israel, bikos e dey sleep with difren men wen e dey en papa house. Like dis, una go remove evil from among una.
DEU 22:22 If dem katch anybody dey sleep with anoda man wife, both of dem must die; like dis, una go remove evil from Israel.
DEU 22:23 If virgin don dey engage to one man and anoda man for di town kon sleep with am,
DEU 22:24 una must bring di two of dem kom di town gate kon stone dem die. Una go stone di girl die, bikos e nor kry wen di man dey sleep with am and una go kill di man, bikos e sleep with di woman wey en broda suppose marry; like dis, una go remove evil from among una.
DEU 22:25 But if di man meet di woman for outside di town kon force and rape am, den na only di man go die.
DEU 22:26 Una must nor do anytin to di woman, bikos e nor do anytin wey go make dem kill-am. Dis one na di same tin as wen pesin attack and kill anoda pesin,
DEU 22:27 bikos di man meet am for field and di woman kon dey shaut, but nobody dey der to save am.
DEU 22:28 If one man si virgin wey dey engage kon force and rape am and dem katch dem.
DEU 22:29 Di man wey rape di woman go pay 50 silva give di woman papa and di woman go bi en wife, bikos e don dis-virgin am. E nor go ever fit porshu di woman komot en house till e die.
DEU 22:30 Make nobody marry en papa former wife, bikos dat na disgrace to en papa.
DEU 23:1 If anybody wound or dem kut en private part komot, make una nor let am kom God present.
DEU 23:2 Make una nor let pesin wey nor know en papa kom God present; even to en tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
DEU 23:3 Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
DEU 23:4 Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una.
DEU 23:5 But di Oga una God nor gri listin to Balaam. Di curse wey Balaam suppose curse una, e turn am to blessing bikos di Oga una God love una.
DEU 23:6 As long as una dey dis life, make una nor ever pray for peace or betta tin for dem.
DEU 23:7 Make una nor hate Edom or Egypt pipol, bikos Edom pipol na una brodas and una stay as strenjas for Egypt.
DEU 23:8 Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.
DEU 23:9 Wen una dey go fight una enemies, make una guide unasef against anytin wey nor klean.
DEU 23:10 If anybody dey among una wey nor dey klean, bikos of wetin e do with en body for nite, e must komot di kamp and e nor go enter for sometaim.
DEU 23:11 Wen evening don rish, make e wosh ensef with wota, den wen sun don go down, e fit enter di kamp again.
DEU 23:12 Una must get somewhere outside di kamp where pipol go for dey piss or shit.
DEU 23:13 Una must get shovel among evry oda tin wey una get, so dat wen una shit for outside di kamp, una go dig groun with di shovel den pour di shit for der kon kover am.
DEU 23:14 Bikos di Oga una God dey waka for di kamp to diliver una kon kill una enemies. So una kamp must dey holy, so dat E nor go si anytin wey go make am turn from una.
DEU 23:15 Any slave wey run leave en masta kom meet una, una must nor take am go back.
DEU 23:16 Make dem stay with una for any town wey dem choose and make una nor opress dem.
DEU 23:17 Make nobody for Israel, weda na man or woman, turn ashawo for di temple.
DEU 23:18 Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.
DEU 23:19 If una give money, food or any oda tin to una fellow brodas for Israel, make una nor put intrest at-all.
DEU 23:20 Una fit borrow with intrest give strenja, but nor bi to una own fellow Israel broda and if una keep dis kommand, di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do for di land wey una go soon take as una own.
DEU 23:21 Wen una make promise give di Oga una God, make e nor tey before una do wetin una promise, if not, God go hold una sey una don sin.
DEU 23:22 But e nor go bi sin, if pesin nor make promise or vow at-all.
DEU 23:23 Anytin wey una promise, una must dey kareful sey una do am. And di promise wey una make to di Oga una God must kom from una free mind.
DEU 23:24 If una enter una neighbour vineyard, una fit chop as many grapes as una wont, but make una nor take any one komot from di vineyard.
DEU 23:25 And wen una enter una neighbour grain field, una fit plok di grain head with una hand, but make una nor kut am with knife.
DEU 24:1 Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house.
DEU 24:2 Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man.
DEU 24:3 But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die,
DEU 24:4 di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.
DEU 24:5 Make una nor put man wey just marry among di sojas or gi-am any oda work. E must dey free to spend one year for en house, so dat di wife go dey happy.
DEU 24:6 Wen una borrow pesin money, make una nor take en grindin stone as shorti, bikos dat na di only tin wey di family take dey chop.
DEU 24:7 If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
DEU 24:8 As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una.
DEU 24:9 Make una remember wetin di Oga una God do to Miriam as una dey kom out from Egypt.
DEU 24:10 If una borrow anytin give una neighbour, make una nor enter en house kon take wetin e use as shorti.
DEU 24:11 Una go wait for outside den e go enter en house go bring am for una.
DEU 24:12 If una neighbour na poor man and e kon give una en klot as shorti for di money wey e borrow, make una nor keep dat klot till di next day.
DEU 24:13 Make una take di klot go give who get am wen evening rish, so dat en body go dey warm for nite and e go bless una, den di Oga una God go si una as pipol wey dey do good.
DEU 24:14 Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una.
DEU 24:15 Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.
DEU 24:16 Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
DEU 24:17 Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt.
DEU 24:18 Make una always remember sey una bi slave for Egypt, before di Oga una God kon save una. Na dis make mi give una dis kommand.
DEU 24:19 Wen una harvest una plant kon leave some for di farm, make una nor go back go gada dem. Make una leave doz ones for strenjas; doz wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die, den di Oga una God go bless una for all di work wey una dey do.
DEU 24:20 Wen una dey plok olive fruit from en tree, di ones wey remain bilong to doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die.
DEU 24:21 Wen una dey gada grape for una vineyard, make una nor go back again go gada wetin remain; bikos doz ones na for doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die.
DEU 24:22 Make una remember sey una bi slave for Egypt before and na dis make mi dey kommand una to do all dis tins.
DEU 25:1 If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong.
DEU 25:2 If di judge sey make dem flog di one wey dey wrong, di judge go kommand am make e liedan for en front make dem flog am.
DEU 25:3 But make una nor flog pesin pass forty times, bikos if una flog am pass forty times, den una don disgrace am bi dat.
DEU 25:4 Make una nor stop una melu make e nor chop wen e dey harvest for una.
DEU 25:5 If two brodas dey stay togeda and one die and e nor get boy pikin, di wife wey en husband don die must nor marry anoda man wey nor dey dat family. Instead, di woman husband broda go marry am kon kare for am.
DEU 25:6 Den di first boy wey di woman go born, go ansa dat one wey don die name, so dat dem nor go forget di broda name for Israel.
DEU 25:7 But if di broda sey e nor go fit marry en dead broda wife, den make di woman go ripot to di eldas for di town gate sey, “My husband broda sey e nor fit keep en broda name for Israel; so e nor gri marry mi!”
DEU 25:8 Den di eldas for di town go koll and tok to am. If e still sey, “I nor won marry am,”
DEU 25:9 den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!”
DEU 25:10 Den dem go dey koll en family, “Family wey dem pul di man sandal komot en leg.”
DEU 25:11 If two men dey fight with hand and one wife kon join help en husband attack di oda, den di woman use en hand take hold di oda man private part,
DEU 25:12 una go kut di woman hand komot and make una nor sorry for am.
DEU 25:13 Wen una dey measure tins, una must measure well
DEU 25:14 and make una get only one kontaina for una house to take measure.
DEU 25:15 Make una always dey use di rite skale take measure, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una.
DEU 25:16 Doz wey dey measure with fake skale, dey sin against di Oga una God.
DEU 25:17 Make una nor ever forget wetin Amalek pipol do una wen una just dey kom out from Egypt.
DEU 25:18 Dat time, as una taya and dey hongry, bikos dem nor dey fear God, dem attack una kon kill doz wey dey stagga dey kom for back.
DEU 25:19 So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.
DEU 26:1 Wen una enter di land wey di Oga una God won give una as una own and una don win evribody for der,
DEU 26:2 make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name.
DEU 26:3 Make una go meet di priest wey dey der for dat time kon tell am, “With dis gift, wi won make di Oga awa God know sey wi don enter di land wey E promise awa grand-grand papa sey E go give us.”
DEU 26:4 Den di priest go take di basket from una hand kon go put am for di Oga una God altar.
DEU 26:5 Den una go sey, “Awa papa Jakob waka from Aramean go stay for Egypt as strenja. En family for dat time, nor many, but wen dem dey komot Egypt, dem kon plenty and dem bi strong pipol naw.
DEU 26:6 Wen Egypt pipol dey opress and ponish us as dia slaves,
DEU 26:7 wi kry to God wey bi awa grand-grand papa God. E hear awa kry kon si as wi dey sofa and as Egypt pipol dey ponish and trit us.
DEU 26:8 So God take us komot from Egypt with en pawa, en strong hand and all en pawaful signs and wonders.
DEU 26:9 Den E bring us kom dis place kon give us dis land wey full with milk and honey!
DEU 26:10 And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am.
DEU 26:11 Afta una don woship am, una go celebrate bikos of all di good tins wey di Oga una God don give una and una family, di Levi and di strenjas wey dey stay among una.
DEU 26:12 Evry three years, una must offa special tithe for una plants. For dat year, una must give una tithe to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go dey si food chop for di town.
DEU 26:13 Den for di Oga una God present, una go sey, “Wi don take di holy gift from awa house kon gi-am to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, just as Yu kommand us. Wi neva forget and wi don do evritin wey Yu kommand.
DEU 26:14 Even wen wi dey mourn, wi nor chop any one; wen wi nor dey klean at-all, wi nor tosh am and wi neva offa any of am to dead body. Wi don obey di Oga awa God and wi don do evritin wey Yu kommand us.
DEU 26:15 Naw, make Yu look down from yor holy house for heaven kon bless Israel wey bi yor pipol and di land wey Yu promise awa grand-grand papa sey, Yu go give us. Di land wey full with milk and honey.”
DEU 26:16 Today, di Oga una God don kommand una to obey all en laws and rules. So make una dey sure sey una dey obey dem with all una heart.
DEU 26:17 Una don tok today sey na di Oga bi una God. And una don promise to do wetin E tok and obey en kommand, laws, rules and to do evritin wey E tell una.
DEU 26:18 Today, God don sey una bi en pipol, en betta gift wey E value well-well, just as E promise, so una must obey en kommand.
DEU 26:19 If una obey am, E go karry una high pass evry oda pipol wey E kreate. Den una go get praiz, honor and evribody go dey tok good about una. Una go bi holy pipol to di Oga una God, just as E promise.
DEU 27:1 Den Moses and di eldas for Israel kommand di pipol sey: “Make una obey all di kommand wey I dey give una today.
DEU 27:2 Wen una cross Jordan River kon enter di land wey di Oga una God dey give una, make una gada some big stones kon pash dem.
DEU 27:3 Wen una don cross di river won kon enter di land wey milk and honey full, wey di Oga dey give una, just as una grand-grand papa God promise una, make una rite all dis kommand put for di stones.
DEU 27:4 Wen una don cross Jordan River, make una gada di stones for Mount Ebal kon pash dem, just as I dey kommand una today.
DEU 27:5 Den for der, make una build altar for di Oga una God and make una nor use anytin take kut dem at-all.
DEU 27:6 Una go build di Oga una God altar with betta stones; nor bi with ones wey dem kut, den una go offa burnt ofrin for der give di Oga una God.
DEU 27:7 Una go still offa fellowship ofrin kon chop dem for der as una dey happy for di Oga una God present.
DEU 27:8 Una must rite all dis kommand for di stone and una go rite am as evribody go fit take si am.”
DEU 27:9 Den Moses and Levi priests kon tok to Israel pipol: “Israel pipol, make una kwayet and listin! Today, una don bi di Oga una God pipol.
DEU 27:10 So una must obey di Oga una God as una dey keep all dis kommand and laws wey I dey give una today.”
DEU 27:11 Dat day, Moses still tell dem:
DEU 27:12 “Wen una cross Jordan River, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Josef and Benjamin tribe must stand on-top Mount Gerizim kon bless di pipol.
DEU 27:13 And Reuben, Gad, Asher, Zebulun, Dan and Naftali tribe go stand on-top Mount Ebal kon curse any tribe wey nor follow God kommand.
DEU 27:14 “Den Levi tribe go shaut give Israel pipol sey:
DEU 27:15 ‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God.
DEU 27:16 Anybody wey nor respet en papa and mama, na curse go follow am.
DEU 27:17 Anybody wey tif en neighbour propaty or kut en neighbour land join e own, na curse go follow am.
DEU 27:18 Anybody wey go show blind man wrong road, na curse go follow am.
DEU 27:19 Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am.
DEU 27:20 Anybody wey sleep with en papa wife, na curse go follow am, bikos e nor gri honor en papa.
DEU 27:21 Anybody wey go sleep with animal, na curse go follow am.
DEU 27:22 Anybody wey sleep with en sista, weda na en papa or mama pikin, na curse go follow am.
DEU 27:23 Anybody wey sleep with en wife mama, na curse go follow am.
DEU 27:24 Anybody wey hide go kill en neighbour, na curse go follow am.
DEU 27:25 Anybody wey kollect money to kill pesin wey nor do anytin, na curse go follow am.
DEU 27:26 Anybody wey nor gri obey or keep dis law and kommand, na curse go follow am.
DEU 28:1 If una really obey God kon keep en kommand wey I dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipol for di world.
DEU 28:2 Una go get all dis blessings if una obey di Oga una God.
DEU 28:3 God go bless una towns and una fields.
DEU 28:4 God go bless una shidren and una plants. E go still bless una animals and dia pikin wey dem go born.
DEU 28:5 E go bless una basket and una plate.
DEU 28:6 Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go bless am.
DEU 28:7 God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!
DEU 28:8 God go kommand blessing for una aria and for evritin wey una dey do; yes, E go bless una for di land wey E dey give una.
DEU 28:9 If una obey di Oga una God kommand kon do as E tok, E go make una en holy pipol, just as E promise sey e go bi.
DEU 28:10 Den evribody for di eart go si sey una bilong to God and dem go respet una.
DEU 28:11 God go make una shidren, animal and plant many kon make una prosper for di land wey E promise una grand-grand papa sey, E go give una.
DEU 28:12 God go send rain from en rish store kom meet una for di rite time and E go bless all di work wey una dey do. Una go dey give to many kountries, but una nor go ever borrow from dem.
DEU 28:13 If una listin well to di Oga una God kommand and if una obey dem with kare, God go make una bi di head and nor bi tail and una go always dey on-top and nor dey under.
DEU 28:14 Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.
DEU 28:15 But if una forget di Oga una God and una nor gri obey en kommand and laws wey I dey give una today, den all dis curse go kom meet una with full force:
DEU 28:16 God go curse una towns and fields.
DEU 28:17 E go curse una basket and una plate.
DEU 28:18 God go curse una shidren and una plants. E go still curse una animals and dia pikin wey dem go born.
DEU 28:19 Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go curse am.
DEU 28:20 Na God by ensef go send curse, problem, wahala, konfushon and E go dey fight una for evritin wey una dey do, until una skata and die finish, bikos of di wiked tins wey una dey do and bikos una don turn from am.
DEU 28:21 God go send diziz kom meet una, until nor of una go remain for di land wey una go soon enter go stay.
DEU 28:22 God go kill una with bad diziz, fever, sore, kro-kro and kold. Dis diziz go attack una until una die finish.
DEU 28:23 Di sky on-top una head go strong like bronze and di eart under una leg go strong like iron.
DEU 28:24 God go turn una rain wey dey fall for una land to powder and san-san; e go fall on-top una until una die finish.
DEU 28:25 God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
DEU 28:26 Una dead body go bi food for di birds for sky and for wiked animal for di eart and nobody go fit porshu dem.
DEU 28:27 God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.
DEU 28:28 God go ponish una with madness, una eyes go blind and E go konfuse una mind.
DEU 28:29 For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.
DEU 28:30 Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit.
DEU 28:31 Dem go kill una melu for una own eye, but una nor go chop for inside. Dem go tif una donkey for una eye and dem nor go bring dem kom back. Dem go give all una sheep to una enemies and nobody go dey to save una.
DEU 28:32 God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.
DEU 28:33 Strenjas go kom chop di plants wey una sofa plant and dem go opress una still una die.
DEU 28:34 All dis tins wey dey happen go make una mad.
DEU 28:35 God go make boil wey dem nor fit cure, katch una knee and legs. In-short, di boil go kover una from head go rish una leg.
DEU 28:36 God go karry una with di king go meet pipol wey una with una grand-grand papa neva hear of before and una go serve and woship gods wey dem make with wood and stone.
DEU 28:37 For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.
DEU 28:38 Una go plant plenty seed, but na small tin una go harvest, bikos siti-siti go chop evritin wey una plant.
DEU 28:39 Una go plant and kare for una vineyard, but una nor go drink di wine or chop di grapes, bikos worm go distroy evritin.
DEU 28:40 Una go plant olive tree for una land, but una nor go ever use di olive oil, bikos di fruits go drop before e ripe.
DEU 28:41 Una go get shidren, but dem go die finish, bikos dem go katch dem as slaves go anoda kountry.
DEU 28:42 Wiked insect go distroy una trees and plants.
DEU 28:43 Di strenjas wey dey among una go dey strong well-well, while una go dey weak evriday.
DEU 28:44 Dem go dey borrow una money, but una nor go borrow anybody. Dem go bi head and una go bi tail!
DEU 28:45 If una nor gri listin to di Oga una God or obey en kommand and law wey E give una, all dis curse go porshu una, until e distroy all of una.
DEU 28:46 Di curse go bi sign against una and una shidren-shidren forever.
DEU 28:47 Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una,
DEU 28:48 una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
DEU 28:49 God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;
DEU 28:50 pipol wey wiked well-well and dem nor go respet una old pipol or pity for una yong ones.
DEU 28:51 Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die.
DEU 28:52 Dem go attack una towns until all di strong walls, (di walls wey una trust sey go protet una) go fall rish groun. Dem go attack all di towns for di land wey di Oga una God don give una.
DEU 28:53 Bikos of di honga and ponishment wey una enemies put una, una go dey chop una own shidren wey di Oga una God give una.
DEU 28:54 Di man among una wey kwayet pass, go turn kon attack en broda, en wife and en shidren wey remain.
DEU 28:55 En own shidren flesh wey e dey chop, e nor go give anybody as nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemy put una for una own town.
DEU 28:56 Di woman wey dey kwayet and gentol among una, wey nor go even put en leg for groun, bikos of how e fine rish, go turn kon attack en husband and shidren
DEU 28:57 and e go chop some since nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemies put una for una own town.
DEU 28:58 “If una nor gri obey my law, di tins wey dem rite for dis book or una nor gri fear di Oga una God wonderful name,
DEU 28:59 God go make una and una shidren-shidren ponishment many and di ponishment go tey well-well.
DEU 28:60 E go give una all doz diziz wey una dey fear for Egypt and dem go trobol una forever.
DEU 28:61 Di Oga una God go still ponish una with difren sickness wey nor dey join dis ones and E go dey bring dem kom, until una don die finish.
DEU 28:62 Even doh una many like di stars for sky, na only some of una go remain, bikos una nor gri listin to God.
DEU 28:63 Just as e sweet God to prosper and make una plenty, na so too God go dey happy to distroy una. “E go remove una from di land wey una won enter go stay,
DEU 28:64 bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!
DEU 28:65 For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry.
DEU 28:66 Na so-so fear una go dey fear both for day time and for nite, bikos una nor know wen una go die.
DEU 28:67 For morning time, una go sey, ‘If to sey na evening wi dey’ and for evening time, una go sey ‘If to sey na morning wi dey!’ Dis na bikos, di kind tins wey una go dey si around una go make una dey fear.
DEU 28:68 Den God go put una for ship kon send una go back to Egypt, to di place wey E promise sey una nor go ever si again. Den for der, una go sell unasef give una enemies as slaves, but nobody go gri buy una.”
DEU 29:1 Dis na di kovenant wey God kommand Moses sey make e make with Israel pipol wen dem dey Moab, plus di kovenant wey E make with dem for Mount Sinai.
DEU 29:2 Moses gada evribody for Israel kon tell dem, “Una don use una own eye take si evritin wey God do to Fero, all en savant and di whole Egypt.
DEU 29:3 Una eye don si en great judgement, signs and wonders.
DEU 29:4 But till today, God neva make una undastand all dis tins or give una eyes wey fit si or ear wey dey hear!
DEU 29:5 I karry una thru di wildaness for forty years, but una klot or sandal nor tear.
DEU 29:6 Una nor chop bread or drink wine or any oda drink, but E give una food, so dat una go know sey na-im bi di Oga una God.
DEU 29:7 “Wen wi rish here, King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan kom fight us, but wi win dem.
DEU 29:8 Wi take dia land kon gi-am to Reuben, Gad and half of Manasseh tribes as dia own.
DEU 29:9 “So make una obey di words wey dey dis kovenant, so dat e go betta for una for evritin wey una dey do.
DEU 29:10 Today, all of una stand before di Oga una God, di head for di tribes, una eldas, una ofisas, evry man for Israel,
DEU 29:11 una small pikin, wifes and di strenjas wey dey stay with una, plus doz wey dey kut wood or karry wota,
DEU 29:12 so dat una go asept di kovenant wey di Oga una God dey make with una today.
DEU 29:13 Today, God go sey una bi en pipol and na-im bi una God, bikos na-im promise una and una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob.
DEU 29:14 Nor bi only una I dey make dis kovenant with,
DEU 29:15 but na with all di pipol wey stand with una for di Oga awa God present today, even with doz wey nor dey with us today.
DEU 29:16 “(Una know how wi dey live awa life wen wi dey Egypt and how wi take cross many nashons as wi dey travel.
DEU 29:17 Una si di bad tins and di juju wey dem make with wood, stone, silva and gold.)
DEU 29:18 Make no man, woman, tribe or family among una leave di Oga una God kon go woship gods for oda kountries. Make nobody among una get any tree wey go bear fruit wey bitter or fit kill.
DEU 29:19 “Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad.
DEU 29:20 God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.
DEU 29:21 God go pick and judge only di pesin from all di tribes for Israel akordin to all di curse wey dey dis Law Book.
DEU 29:22 “En shidren-shidren wey go kom afta una, plus di strenjas wey go kom from far place, all of dem go si di wahala for dat land and di sickness wey God go send for dia head.
DEU 29:23 Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.
DEU 29:24 Den all di nashons go ask, ‘Wetin make God do all dis tins for dis land? Wetin make God dey vex like dis?’
DEU 29:25 “Den di pipol go sey, ‘Na bikos dem nor gri obey di kovenant wey God wey bi dia grand-grand papa God make with dem wen E bring dem kom out from Egypt.
DEU 29:26 Dem kon go serve and woship oda gods wey dem nor even know and God sey make dem nor woship doz gods.
DEU 29:27 Na dis tin make God dey vex for dem well-well for dis land and naim make am ponish dem with all di curse wey dey dis book.
DEU 29:28 So God don vex remove dem from dia land kon karry dem go anoda land and evribody dey si as e bi today.’ ”
DEU 29:29 Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.
DEU 30:1 I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay for di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey I give una.
DEU 30:2 If una and una shidren-shidren turn kom meet God kon obey all en kommand wey I dey give una today, with una heart and soul,
DEU 30:3 den di Oga una God go sorry for una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una go kon make una prosper again.
DEU 30:4 Even if una skata for evriwhere for di eart, di Oga una God go gada and bring una kom back to una land.
DEU 30:5 Di Oga una God go take una enter di land wey E give una grand-grand papa, so dat e go bi una own too. E go make una prosper and many pass una grand-grand papa dem.
DEU 30:6 Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.
DEU 30:7 But di Oga una God go put all dis curse for una enemies head and doz wey dey won kill una.
DEU 30:8 Den una go obey God vois kon keep all en kommand wey I dey kommand una today.
DEU 30:9 For all di work wey una go do with una hand, God go make una prosper. Una and una animals go get plenty pikin and una plant go produce plenty food. Bikos God go dey happy to make una prosper, just as E dey happy wen una grand-grand papa dey prosper.
DEU 30:10 Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.
DEU 30:11 Di way wey I dey kommand una today, nor dey too strong for una and e nor too mush.
DEU 30:12 E nor dey for heaven so make nobody sey, “Who go-go heaven go bring di kommand kom for us, so dat wi go hear and do am?”
DEU 30:13 Di kommand nor dey for di oda side for di river, so una nor nid to ask, “Na who go cross di river go bring am for us, so dat wi go hear and obey am?”
DEU 30:14 But di word and kommand dey here with una. Una know am and una fit read am, so make una obey am.
DEU 30:15 Make una know sey, “I dey give una choice between good and bad; life and deat.
DEU 30:16 If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.
DEU 30:17 “But if una turn against God and E kommand kon dey woship juju and oda gods,
DEU 30:18 I dey tell una today sey una go die! Una nor go stay tey for di land wey una dey cross Jordan River go take as una own.
DEU 30:19 “I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life.
DEU 30:20 Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”
DEU 31:1 Den Moses tell Israel pipol dis word.
DEU 31:2 “I don rish one hundred and twenty years naw and I nor go fit still bi una leader again. God don tell mi sey, ‘Yu nor go follow dem cross Jordan River.’
DEU 31:3 Na di Oga una God bi di Pesin wey go cross before una. E go distroy all di oda kountries for una and una go porshu dem komot. Oga God sey na Joshua go lead una cross Jordan River.
DEU 31:4 God go ponish dis kountries just as E do to Amor pipol kings, Sihon and Og kon distroy dia land.
DEU 31:5 God go put dem for una hand and na wetin I kommand una, una must do to dem.
DEU 31:6 Make una dey strong and make una heart nor shake; make una nor fear dem at-all, bikos na di Oga una God dey go with una. E nor go leave or forget una.”
DEU 31:7 Den Moses koll Joshua kom out for all di pipol present kon sey, “Make yu dey strong and make yor heart nor shake, bikos na yu go lead dis pipol go di land wey God promise dia grand-grand papa and na yu go make dem get am.
DEU 31:8 God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”
DEU 31:9 Moses rite all dis law kon gi-am to di priest, Levi shidren wey karry God Kovenant Box and e still give di law to all di eldas for Israel.
DEU 31:10 Moses kommand dem: “For di last day for evry seven years, for di rite time for di year wey dem dey kansol pipol debt, durin di time wey dem dey do Shelta First,
DEU 31:11 wen Israel pipol go kom before di Oga una God for di place wey E choose, yu must read dis law for dem make dem hear.
DEU 31:12 Make una gada all di pipol: men, wimen and shidren, plus all di strenjas among una, so dat dem go hear, learn and know how to fear di Oga una God kon obey all en law.
DEU 31:13 Den dia shidren wey know di law, go still hear, learn and fear di Oga una God as long as una dey di land wey una dey cross Jordan River go stay.”
DEU 31:14 Den God tell Moses, “Di time wey yu go die don near well-well. Make yu koll Joshua kom di Tabanako, so dat I go fit tell am wetin e go do.” So Moses and Joshua go di Tabanako where di pipol gada put.
DEU 31:15 God appear to dem like kloud for di door-mot.
DEU 31:16 Den God tell Moses, “Yu go soon die, den di pipol go kon dey sin with strenj gods for di land where dem dey go. Dem go rijet mi kon break my kovenant wey I make with dem.
DEU 31:17 For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’
DEU 31:18 But dat time, I go really hide my face, bikos of all di wikedness wey dem don do as dem dey serve oda gods.
DEU 31:19 “But make yu rite dis song for yorsef kon tish evribody for Israel. Make sure sey dem know am, so dat dis song go bi my witness against dem!
DEU 31:20 Bikos afta I don bring dem kom di land wey I promise dia grand-grand papa; di land wey get milk and honey; where dem go chop beleful kon get body, dem go turn go serve anoda god kon rijet and break my kovenant.
DEU 31:21 Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”
DEU 31:22 So for dat day, Moses rite di song kon tish evribody for Israel
DEU 31:23 and God kon make Joshua, Nun pikin leader for Israel sey, “Make yu dey strong and nor fear, bikos yu go take Israel, my pipol go di land wey I promise dem and I go dey with yu.”
DEU 31:24 Wen Moses rite finish for dia present,
DEU 31:25 e kon kommand Levi pipol wey dey karry God Kovenant Box sey,
DEU 31:26 “Make una take di Law Book kon put am near di Oga una God Kovenant Box. E go dey der as witness against una,
DEU 31:27 bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die?
DEU 31:28 Make all di tribes kom meet mi; una eldas and ofisas, so dat I go tok to dem by mysef about dis tins kon koll di heavens and eart to bi witness against dem.
DEU 31:29 Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”
DEU 31:30 Den Moses sing di words for di song from biginnin go rish di end, so dat evribody wey dey Israel, go hear am.
DEU 32:1 Heavens make una listin to mi as I dey tok; eart make una listin to di words wey I won tok so.
DEU 32:2 Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.
DEU 32:3 Bikos I go tok about God name and how E dey strong!
DEU 32:4 Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.
DEU 32:5 En pipol nor dey respet or fear am; dem nor dey bihave like en shidren and na dis bi dia sins. Dem wiked well-well and na lie-lie full dia generashon.
DEU 32:6 Dis pipol wey nor get sense at-all, na like dis una won take pay God? Nor bi en bi una papa wey kreate una? Na-im kreate and make una strong.
DEU 32:7 Make una remember as e bi before, make una tink about di generashon wey don pass. Make una ask una papa and una eldas and dem go tell una evritin.
DEU 32:8 Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty; wen E divide evry human being, E give di pipol where dem go stay rish, akordin to di nomba wey dey for heaven.
DEU 32:9 Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.
DEU 32:10 Na empty dirty land for wildaness E for si dem. E dey look and guide dem for evry korna; E dey guide dem as pipol wey E love well-well.
DEU 32:11 Just as di eagle dey wosh en house kon kover en shidren, na so too God spread en feada kon karry dem go up.
DEU 32:12 Na God dey guide dem by ensef, e nor get any oda god wey dey with am.
DEU 32:13 E allow dem travel pass di high place for di land kon chop from di plants wey dey di field. E use honey from di rock and olive oil from strong groun take kare for dem.
DEU 32:14 E feed dem with milk from di animals and with di fats wey dey lamb body. E give dem betta ram and goat form Bashan, plus fine-fine food. Una don drink di wine wey sweet pass wey dem make from grape.
DEU 32:15 But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
DEU 32:16 Dem make am jealous, bikos dem dey serve juju and oda gods.
DEU 32:17 Instead make dem sakrifice give God, dem dey sakrifice give juju and gods wey dem nor know; new gods wey dem just si, even gods wey dia grand-grand papa dem nor know about.
DEU 32:18 Dem don forget di Rock wey bi dia papa and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again.
DEU 32:19 So wen God si all dis tins, E vex bikos en shidren dey disobey am.
DEU 32:20 God sey, “I go rijet dem, I go si wetin go happen to dem; bikos dis generashon dey show sey dem too know and dem nor get sense.
DEU 32:21 Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.
DEU 32:22 Bikos my vexnashon don kause fire and e don burn rish di part wey deep pass for di grave kon distroy di eart and en plants, den e skata di mountins foundashon.
DEU 32:23 I go inkrease dia wahala, I go use all my arrow for dia body.
DEU 32:24 Honga go kill dem, betta sofa go worry dem. I go send wiked animal and bad snakes go chop dem.
DEU 32:25 Di swod go bring deat for outside and for inside, fear go kill both men and wimen; small pikin and di ones wey don big.
DEU 32:26 “I sey, ‘I won kut dem to pieces. I won make pipol forget dem forever.
DEU 32:27 But I nor go like how di enemies go si am, bikos dem nor go undastand and dem go sey, wi too get pawa and nor bi God do all dis tins!’ ”
DEU 32:28 Dem bi pipol wey nor get sense and dem nor fit undastand at-all.
DEU 32:29 How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.
DEU 32:30 How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?
DEU 32:31 Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock and even awa enemies know sey na so e bi.
DEU 32:32 Dia vine na from Sodom and Gomorrah field. Dia grape get poizin and e bitter well-well.
DEU 32:33 Dia wine na snake poizin and e bad like kobra own.
DEU 32:34 God sey, “I nor dey keep all dis tins among di tins wey I value?
DEU 32:35 I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”
DEU 32:36 God go judge en pipol and E go shange en plan about en savant; wen E si sey dia pawa don vanish and nobody remain again, weda na slave or free pesin.
DEU 32:37 E go sey, “Where una gods, di rock wey una bilive sey, e go guide una,
DEU 32:38 wey dey chop di best for una sakrifice kon drink di wine for una drink ofrin? Make dem raiz naw kom help una; make dem kon save and guide una!”
DEU 32:39 God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.
DEU 32:40 Bikos I raiz my hand go heaven kon sey, ‘As long as I dey forever,
DEU 32:41 I go make my lite sharp like swod and my hand go hold di judgement swod well-well; I go revensh doz wey make mi vex kon pay doz wey hate mi!
DEU 32:42 I go make my arrow full with blood and my swod go distroy pipol flesh, doz pipol wey I katch and kill and even di enemies oga blood!’ ”
DEU 32:43 My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.
DEU 32:44 Den Moses go with Joshua, Nun pikin kon sing all di word for di song give di pipol.
DEU 32:45 Wen Moses don sing di song give Israel pipol,
DEU 32:46 e kon tell dem, “All dis words wey I dey tell una today, make una keep am for una mind; una must kommand una shidren to obey all dis law and kommand.
DEU 32:47 All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.”
DEU 32:48 Dat same day, God tell Moses,
DEU 32:49 “Make yu go Abarim hill kountry for Mount Nebo (where bi Moab land opposite Jeriko) den look Kanaan land wey I won give Israel pipol as dia own.
DEU 32:50 Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa,
DEU 32:51 bikos di two of una sin against mi for Israel pipol front for Meribah Kadesh wota for Zin wildaness, wen yu nor respet mi as yu suppose to.
DEU 32:52 Yu go si di land, but yu nor go enter di land wey I dey give to Israel pipol.”
DEU 33:1 Dis na di blessing wey Moses, God savant bless Israel pipol before e die:
DEU 33:2 “God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.
DEU 33:3 Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem.
DEU 33:4 Moses give us God kommand, di special place wey E keep for en pipol, Israel.
DEU 33:5 Na God bi king for Israel wen all di leader among di pipol go gada go meet kon gada all di tribe for Israel as one.”
DEU 33:6 Moses pray for Reuben tribe sey: “Reuben tribe go live and dem nor go die, even doh dem nor plenty.”
DEU 33:7 Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make Yu hear Judah pipol kry kon bring dem togeda as one. Make Yu give dem pawa to take fight and win dia enemies!”
DEU 33:8 Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside.
DEU 33:9 Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant.
DEU 33:10 Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar.
DEU 33:11 Make wi bless God strent and di work wey E don do; bikos E kill di enemies lion, so dat dem nor go fit raiz at-all!”
DEU 33:12 Moses pray for Benjamin tribe sey: “God love Benjamin pipol and dem dey save under am. E dey gada dem from evry side, so dat nor-tin go do dem.”
DEU 33:13 Moses pray for Josef tribe sey: “Make God bless una land with rain and with wota wey dey kom from under di groun.
DEU 33:14 Make betta-betta fruit wey dey grow under di sun dey una land and di fruit for di sizin go bi una own.
DEU 33:15 Make betta fruits kover una hills and mountins.
DEU 33:16 Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.
DEU 33:17 Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”
DEU 33:18 Moses pray for Zebulun and Issakar tribe sey: “Zebulun pipol go prosper as dem dey travel. Make Issakar pipol prosper for dia house.
DEU 33:19 Dem invite strenjas kon dia mountin kon offa di rite sakrifice for der. Dem get dia money from di sea and di wotaside.”
DEU 33:20 Moses pray for Gad tribe sey: “God go bless una wey make en land wide! Gad pipol bi like lion wey won tear pesin hand or head komot from en body.
DEU 33:21 Gad pipol take di best land for diasef; dem give dem di leadership. Wen Israel pipol leaders don gada, na Gad pipol dey first obey God kommand and rules for Israel.”
DEU 33:22 Moses pray for Dan tribe sey: “Dan pipol bi like yong lion wey dey kom out from Bashan.”
DEU 33:23 Moses pray for Naftali tribe sey: “Naftali pipol, favor go follow una and God don bless una well-well; make una kollect di west and sout as una own.”
DEU 33:24 Moses pray for Asher tribe sey: “Make God bless Asher pipol pass evry oda sons; make en brodas karry am high and Asher pipol go dey wosh dia own legs with olive oil.
DEU 33:25 Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.
DEU 33:26 Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.
DEU 33:27 Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!
DEU 33:28 So Israel pipol go stay for peace, Jakob pipol go prosper for di land wey get food and wine and dew go drop from heaven.
DEU 33:29 Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”
DEU 34:1 Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan,
DEU 34:2 plus Naftali Efraim, Manasseh and all Judah land go rish di sea for far.
DEU 34:3 God show am Negev and di valley for Jeriko; di town wey get palm tree and Zoar land.
DEU 34:4 Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”
DEU 34:5 So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok.
DEU 34:6 God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.”
DEU 34:7 Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy.
DEU 34:8 Israel pipol mourn for Moses for thirty days inside Moab wildaness; den dem kon stop to mourn for Moses.
DEU 34:9 Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.
DEU 34:10 E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face.
DEU 34:11 God send am go do many signs and wonders for di king for Egypt, en ofisas and for di whole land.
DEU 34:12 E nor get any oda profet wey don fit do all di strong and mighty tins wey Moses do for Israel pipol present.
JOS 1:1 Afta Moses, God savant don die, God kon tell Joshua wey bi Nun pikin wey bin dey help Moses sey,
JOS 1:2 “My savant Moses don die. So make yu get ready to cross Jordan River! Make yu take dis pipol enter di land wey I don promise to give dem.
JOS 1:3 Anywhere yor leg tosh, I don gi-am to yu, just as I promise Moses.
JOS 1:4 Una land go start from di wildaness wey dey sout for Lebanon go rish di nort. E go rish di great Eufrates River for east (plus evriwhere for Siria) and from der go Mediterranean Sea for west.
JOS 1:5 Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.
JOS 1:6 “Make yu dey strong and get heart! Yu go lead dis pipol go win di land wey I don promise dia grand-grand papa sey, I go give dem.
JOS 1:7 Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.
JOS 1:8 Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.
JOS 1:9 I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”
JOS 1:10 Joshua tell di leaders:
JOS 1:11 “Make una go di kamp kon tell evribody sey, ‘Make una dey ready bikos like three days from naw, una go cross Jordan River kon bigin fight for di land wey di Oga una God won give una.’ ”
JOS 1:12 Joshua kon tell Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe sey:
JOS 1:13 “Hope una remember wetin God savant Moses kommand una? Di Oga una God go give una where una go stay and E dey give una dis land as una propaty.
JOS 1:14 Una wifes, shidren and animal fit dey di land wey Moses give una for Jordan River east, but all una sojas must cross go fight first. Una must help una pipol
JOS 1:15 until God don give una brodas where dem go stay like una and until una win di land wey di Oga una God don sey E go give dem. Den una fit go back to una place wey Moses, God savant don give una for Jordan River east.”
JOS 1:16 So dem ansa Joshua, “Wi go do evritin wey yu tok and wi go-go evriwhere wey yu send us go.
JOS 1:17 Just as wi obey Moses, na so wi go obey yu too. Make di Oga yor God dey with yu as E dey with Moses.
JOS 1:18 “Anybody wey won show sey e sturbon and e nor gri do wetin yu kommand, wi go kill-am. But make yu dey strong kon get heart!”
JOS 2:1 Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.
JOS 2:2 Jeriko king hear sey some pipol from Israel don kom spy di town,
JOS 2:3 so e send pipol go tell Rahab sey: “Di pipol wey dey yor house won spy dis town! So make yu bring dem kom out!”
JOS 2:4 But di woman hide di two men kon ansa, “Yes, dis men really kom my house, but I nor know where dem from kom.
JOS 2:5 Wen time rish to klose di town gate for nite, di men kon go. I nor even know where dem dey go. Make una kwik-kwik porshu dem and una go katch dem!”
JOS 2:6 (Naw, di woman don hide dem for di roof kon put dem under di tins wey dey der.)
JOS 2:7 Di king men kon find di men go di road where dem dey pass go Jordan River. As dem just kom out bigin porshu di men, di gateman kon lock di town gate.
JOS 2:8 So before di two spy go sleep, Rahab klimb go meet dem for di roof
JOS 2:9 kon tell dem, “I know sey God go give una dis town. Wi dey fear una well-well and evribody wey dey stay di town dey shake bikos of una.
JOS 2:10 Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River.
JOS 2:11 Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart!
JOS 2:12 So make una promise and swear with God name sey, bikos I dey good to una, una go dey good to mi and my family. Make una promise sey
JOS 2:13 una nor go kill my papa, mama, brodas, sistas and evritin wey bi my own.”
JOS 2:14 Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”
JOS 2:15 Den Rahab use rope take drop dem thru window. (Dem build Rahab house join di wall for di town and na der e dey stay.)
JOS 2:16 Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”
JOS 2:17 Di men kon tell am, “Di promise wey wi promise nor go do us anytin unless sey yu do as wi sey make yu do:
JOS 2:18 Wen wi attack dis land, make yu tie dis red rope for di window wey yu for allow us kom down, den go pak all yor family enter yor house and evribody where dey stay yor papa house.
JOS 2:19 Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us.
JOS 2:20 But if yu tok wetin wi kom do for here, di swear wey wi swear, don skata bi dat.”
JOS 2:21 Rahab kon sey, “I gri with evritin wey una tok.” E tell dem where dem go pass kon tie di red rope for di window.
JOS 2:22 Dem go di kountry for di hill kon stay der for three days and all di pipol wey dey porshu dem, kon go back. Jeriko men look evriwhere, but dem nor si dem.
JOS 2:23 Den di two men kom down from di hill, cross di river go meet Joshua wey bi Nun pikin kon tell am evritin wey dem don si and know.
JOS 2:24 Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”
JOS 3:1 As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river.
JOS 3:2 Afta three days, di leaders bigin waka round di kamp
JOS 3:3 kon kommand di pipol sey: “Wen una si Levi priest karry una Oga God box wey di kovenant dey inside, una must follow dem for back.
JOS 3:4 But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”
JOS 3:5 Joshua tell di pipol, “Make una go klean unasef, bikos for dis time tumoro, God go do strong mirakle among una.”
JOS 3:6 Joshua tell di priest, “Make una karry di Kovenant Box dey go for di pipol front.” So dem karry di Kovenant Box kon dey go for di pipol front.
JOS 3:7 God tell Joshua, “From today go, I go start to honor yu among Israel pipol, so dat dem go know sey I dey with yu, just as I dey with Moses.
JOS 3:8 Tell di priests sey make dem karry di Kovenant Box and wen dem don rish di wotaside for Jordan River, make dem waka enter di wota small.”
JOS 3:9 Joshua tell Israel pipol, “Make una listin to wetin di Oga una God dey tok!”
JOS 3:10 Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.
JOS 3:11 Si! Di Kovenant Box wey bi di Oga God for di whole eart own, don dey ready to enter Jordan River before una.
JOS 3:12 Naw, make una choose twelf men from di tribes for Israel, one pesin from each tribe.
JOS 3:13 Di priests wey karry God wey dey rule di whole world Kovenant Box, as dia leg tosh di wota for Jordan River, dat place go divide for una.”
JOS 3:14 So di pipol leave dia kamp kon waka dey go cross di river and di priests wey karry di Kovenant Box dey waka for dia front.
JOS 3:15 Wen doz wey karry di Kovenant Box rish di river kon enter di wota (Jordan River dey rush well-well, bikos na harvest time dem dey),
JOS 3:16 di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko.
JOS 3:17 For Jordan River centre, di priests wey karry di Kovenant Box, stand well for dry groun. All di pipol for Israel cross pass for dry groun until evribody for di kountry cross finish.
JOS 4:1 Wen dem don cross finish, God kon tell Joshua,
JOS 4:2 “Selet twelf men from di pipol, one from each tribe.
JOS 4:3 Den yu go tell dem sey, ‘Make una pick twelf stones from Jordan River centre, di very place where di priests stand put.’ Den, dem go karry di stones follow yu and yu go put am for di place where una go stay dis nite.”
JOS 4:4 Joshua koll di twelf men wey e choose from each tribe
JOS 4:5 kon tell dem, “Make una go for di Oga una God box front wey dey Jordan River centre. Each of una go put one stone for shoulder akordin to di tribes for Israel.
JOS 4:6 Di stones go make una dey remember dis tin wey happen and wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin make dis stones dey important to una?’
JOS 4:7 den make una tell dem how Jordan River take stop to rush, bikos of God Kovenant Box. Wen di box cross Jordan River, di wota stop to rush. Dis stones go make Israel pipol dey always remember wetin happen.”
JOS 4:8 So, Israel pipol do wetin Joshua tell dem. Dem pick twelf stones from di river centre, akordin to di tribes for Israel, just as God kommand Joshua. Dem karry dem go di kamp kon put am for der.
JOS 4:9 For di river centre where di priests wey karry di Kovenant Box stand put, Joshua kon put twelf stones for der. Di stones still dey der still today.
JOS 4:10 Naw, di priests wey karry di Kovenant Box stand for Jordan River centre until di pipol do evritin wey God kommand, just as Moses tell Joshua. Di pipol cross kwik-kwik
JOS 4:11 and wen di pipol don cross finish, di Kovenant Box and di priest kon cross too.
JOS 4:12 Na Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe first cross, bikos na dem go first attack for war, just as Moses kommand.
JOS 4:13 E rish 40,000 strong sojas wey mash dey go fight for Jeriko field and God dey with dem.
JOS 4:14 Dat day, God give Joshua honor for Israel pipol front. Dem respet am till e die, just as dem bin respet Moses.
JOS 4:15 God kon tell Joshua,
JOS 4:16 “Make yu tell di priests wey karry di Kovenant Box make dem komot from Jordan River.”
JOS 4:17 So Joshua tell di priests, “Make una kom out from Jordan!”
JOS 4:18 Di priests wey karry di Kovenant Box kon komot from di river centre and as dem just enter dry land, di wota for Jordan kon start to rush well-well again.
JOS 4:19 Di pipol cross Jordan River for di tent day for di first mont kon stay for Gilgal wey dey di east side for Jeriko borda.
JOS 4:20 Di twelf stones wey Joshua take from Jordan River, e arrange dem for one place for Gilgal.
JOS 4:21 Joshua tell Israel pipol, “Wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin dis stones mean?’
JOS 4:22 Make una tell dem, ‘Na wen Israel pipol cross Jordan River for dry groun.’
JOS 4:23 Di Oga una God dry Jordan River for una and una waka pass, just as E dry di Red Sea make wi waka pass.
JOS 4:24 E do am make all di kountry for eart know sey na God get all di pawa, so una must always obey di Oga wey bi una God.”
JOS 5:1 Wen Amor pipol kings for Jordan River west and Kanaan kings wey dey near di wotaside for Jordan River hear how God take dry Jordan River for Israel pipol make dem waka pass, dem kon bigin fear well-well.
JOS 5:2 For dat time, God kon tell Joshua, “Make yu use stone take make knife kon sekonsaiz Israel pipol again.”
JOS 5:3 So Joshua make di knife kon sekonsaiz dem for where dem dey koll Sekonsishon Hill.
JOS 5:4 Joshua sekonsaiz dem, bikos all di men wey old rish to fight wen den komot from Egypt, don die for di desert.
JOS 5:5 Naw, doz wey dem sekonsaiz, na shidren wey dem born for di desert afta dem komot from Egypt and dem neva sekonsaiz at-all.
JOS 5:6 True-true, na forty years Israel pipol take travel pass di desert, so all di men wey dey fight wen dem komot from Egypt don die finish for di desert, bikos dem disobey God and God don swear sey as dem disobey am, E nor go let dem si di land wey E don promise to give dem; di land where milk and honey full.
JOS 5:7 God replace dem with dia sons wey Joshua sekonsaiz. Dem neva sekonsaiz dem before; dia papa nor fit sekonsaiz dem for road.
JOS 5:8 Wen dem don sekonsaiz all of dem, dem kon stay di kamp until dia body dey okay.
JOS 5:9 God tell Joshua, “Today, di disgrace wey una karry kom from Egypt, I don remove am from una head.” So na Gilgal dem dey koll dat place kon rish today.
JOS 5:10 Israel pipol stay for Gilgal and dem celebrate di Passova for Jeriko field for evening for di fourteent day for di mont.
JOS 5:11 Di day afta di Passova, Israel pipol chop some food wey grow for di land, plus bread wey nor get yist and rice wey dem roast.
JOS 5:12 From di day wey dem chop di food wey grow for di land, manna kon stop to fall. So, Israel pipol nor chop manna again.
JOS 5:13 Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”
JOS 5:14 Di man ansa, “Na mi bi di oga among God sojas for heaven. Naw I don kom!” Joshua fall face groun kon sey, “Wetin my oga won tell en savant?”
JOS 5:15 Di oga among God sojas for heaven kon tell Joshua, “Make yu pul yor sandals, bikos di place wey yu stand put so, dey holy.” So Joshua do as di man kommand am.
JOS 6:1 Naw, dem lock and dey guide Jeriko gate, so dat Israel pipol don go fit attack am. Dem nor gri make anybody enter inside or go outside.
JOS 6:2 God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko for una, plus di king and en sojas.
JOS 6:3 Make una sojas mash round di town ones and make una do like dat for six days.
JOS 6:4 Make yu tell seven priests make dem karry seven ram horn for di box front, den for di sevent day, make una mash round di town seven times, while di priests go dey blow di trumpet.
JOS 6:5 Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”
JOS 6:6 So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”
JOS 6:7 So e tell di sojas, “Make una waka for front kon mash round di town, while many sojas go dey waka for di Kovenant Box front.”
JOS 6:8 Wen Joshua orda en sojas, di seven priests karry di ram horn for God present for front kon bigin blow di horn as God Kovenant Box dey follow dem for back.
JOS 6:9 Many sojas dey mash for front of di priests wey dey blow di horn, while di oda guards dey mash follow di box for back dey blow ram horn too.
JOS 6:10 Naw, Joshua tell di sojas, “Make una nor shaut or make nois; make una nor tok anytin until di day wey I go tell una sey make una shaut or make nois!”
JOS 6:11 So Joshua make sure sey dem karry di Kovenant Box round di town only ones a day. Den dem go back go sleep for dia kamp.
JOS 6:12 For early morning di next day, Joshua and di priests karry di Kovenant Box.
JOS 6:13 Di seven priests wey karry di seven ram horn for di Kovenant Box front, mash dey blow di horn round di town. Many sojas dey mash for dia front, while di oda guide dey follow for back and dem dey blow dia horn too.
JOS 6:14 Dem mash round di town ones for di sekond day, den dem go back to dia kamp. Dem do like dis for six days.
JOS 6:15 For di sevent day, dem wake-up for early morning kon mash round di town as before, but dis time, dem mash round am seven times.
JOS 6:16 Wen di sevent time rish, di priests kon blow di ram horn and Joshua kon tell di sojas, “Make una shaut for war, bikos God go give dis town to una!
JOS 6:17 Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.
JOS 6:18 But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol.
JOS 6:19 All di gold and silva, plus di bronze and all di iron tins, na God get dem. All of dem must go God store house.”
JOS 6:20 Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.
JOS 6:21 Dem use dia swod take kill evritin wey dey breath for di town, both man and woman, small pikin and old pipol, plus all di animals.
JOS 6:22 Joshua kon tell di two men wey kon spy di land before sey, “Make una go di ashawo house den bring en and evribody wey dey di house kom out, just as una promise am.”
JOS 6:23 So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.
JOS 6:24 But dem burn di town and evritin wey dey inside, esept di gold, silva, bronze and di iron tins wey dem karry go God store house.
JOS 6:25 But Joshua nor kill Rahab wey bi ashawo, en family and evritin wey bilong to am. Rahab kon stay for Israel, bikos e hide di pipol wey Joshua send go spy Jeriko.
JOS 6:26 For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”
JOS 6:27 God dey with Joshua and pipol kon know am for evriwhere.
JOS 7:1 Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.
JOS 7:2 Joshua send men from Jeriko sey make dem go spy Ai town (Ai town dey near Bet-Aven, di east side for Bethel land) e kon tell dem, “Make una go spy di land.” So di men kon go spy di town.
JOS 7:3 Dem kom back kon tell Joshua, “Nor send all di sojas go, about two or 3,000 sojas go distroy di whole Ai town. Nor disturb di whole sojas, bikos Ai na small town.”
JOS 7:4 So about 3,000 men kon go, but dem run from Ai men.
JOS 7:5 Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.
JOS 7:6 Joshua tear en klot; en and di leaders for Israel fall for groun before di Kovenant Box until evening and dem pak dirty full dia head
JOS 7:7 Joshua kon pray, “My Oga God! Wetin make Yu take us cross Jordan River kon give us to Amor pipol, so dat dem go distroy us?
JOS 7:8 “Why wi nor just stay for di oda side for Jordan River! Wetin I go tok naw wey Israel pipol dey run from dia enemies?
JOS 7:9 Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”
JOS 7:10 God ansa Joshua, “Make yu get up! Wetin make yu face groun dey mourn?
JOS 7:11 Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty.
JOS 7:12 Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.
JOS 7:13 “Make yu get up! Go santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro, bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight una enemies until una remove wetin make una dirty.”
JOS 7:14 “ ‘Wen day break, una must kom akordin to tribe. Di tribe wen God go choose go kom akordin to village. Di village wey God go choose go kom akordin to family. Di family wey God go choose must kom man by man.
JOS 7:15 Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace Israel pipol.’ ”
JOS 7:16 Di next day for early morning, Joshua kon tell Israel pipol make dem kom tribe by tribe and God kon choose Judah tribe.
JOS 7:17 Joshua sey make di pipol for Judah kom village by village and God kon choose Zera village. Joshua sey make Zera pipol kom family by family and God kon choose Zabdi family.
JOS 7:18 Joshua sey make Zabdi Family kom man by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.
JOS 7:19 So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”
JOS 7:20 Akan kon tell Joshua, “Na trut. I don sin against Israel God:
JOS 7:21 From di tins wey wi karry from Jeriko, I si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent centre.”
JOS 7:22 So Joshua send pipol go di tent. Di tins dey for di tent and di silva dey under dem.
JOS 7:23 Dem take all of dem from di tent centre kon go give Joshua and Israel pipol kon put am for where God go for si am.
JOS 7:24 Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).
JOS 7:25 Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put wahala for yor head today!” So, evribody for Israel stone en, en family and evritin wey e get until dem die finish, den dem kon burn dem.
JOS 7:26 Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.
JOS 8:1 God tell Joshua, “Make yu nor fear or bigin shake! Take all di sojas make una mash go Ai! Si, I dey give yu Ai king, plus di pipol and di town.
JOS 8:2 Make yu do wetin yu do for Jeriko to Ai, en king and en pipol, but una fit keep dia animals for unasef. Naw, make una dey ready to attack di town from back!”
JOS 8:3 Joshua and all di sojas kon mash dey go Ai town. Joshua choose 30,000 strong sojas kon send dem go for nite.
JOS 8:4 E tell dem, “Make una hide for di town back. Make una nor too go far from di town and all of una must dey ready!
JOS 8:5 Mi and di oda sojas go mash go di town. Wen dem kom out kon fight us like before, wi go run leave dem.
JOS 8:6 Dem go dey porshu us until wi don draw dem go far from di town, bikos dem go sey, ‘Dem dey run from us like before.’
JOS 8:7 Den una go kom out from where una hide put kon distroy di town. Di Oga una God go give di town to una.
JOS 8:8 Wen una don enter di town, make una start to burn am. Make una do as God don tok! Si, I don give una ordas.”
JOS 8:9 Joshua send dem and dem kon go hide for di west side for Ai, between Ai and Bethel. Dat nite, Joshua stay with di sojas.
JOS 8:10 As day just break, Joshua gada di sojas with di leaders for Israel and dem kon mash go Ai for front.
JOS 8:11 All di sojas dey mash with am as dem near di town. Dem kon stay for di nort side for Ai wey dey di oda side for di valley.
JOS 8:12 Joshua hide 5,000 men for di west side between Bethel and Ai.
JOS 8:13 Di sojas dem don ready; both di ones wey dey nort and di ones wey dey hide for west. For dat nite, Joshua kon go di valley centre.
JOS 8:14 Wen Ai king si Israel pipol, en and all en sojas kwik-kwik get up di next day go fight Israel for Arabah. But Ai king nor know sey some men hide for di town back.
JOS 8:15 Joshua and all di sojas for Israel kon do like sey Ai men dey win dem, so dem kon dey run go di desert.
JOS 8:16 Ai king kon sey make all en sojas porshu dem; dem porshu Joshua and e take dem far komot from dia town.
JOS 8:17 No soja remain for Ai or Bethel; all of dem don porshu Israel pipol and dem leave di town open.
JOS 8:18 God kon tell Joshua, “Dis swod wey dey yor hand, make yu point am face Ai, bikos I don gi-am to yu and yor sojas.”
JOS 8:19 Wen e stresh en hand, di men wey hide before kon get up attack di town. Dem enter di town kon bigin burn am at wons.
JOS 8:20 Wen Ai men turn back, dem si smoke from dia town dey go heaven and fear katch dem and dem nor fit run go anywhere. Dis time, di men wey dey run before go di desert kon turn back face Ai men wey dey porshu dem.
JOS 8:21 Wen Joshua and Israel pipol si sey di men wey hide don enter di town and di town don dey katch fire, dem kon turn and bigin kill Ai men.
JOS 8:22 For dat same time, di men wey burn di town don kom out kon fight, so Ai men kon dey di middle. Israel sojas kill all of dem.
JOS 8:23 But dem katch di king alive, bring am kon meet Joshua.
JOS 8:24 Wen Israel pipol don kill all di men for Ai wey porshu dem go desert, all of dem kon go back to Ai go kill evribody wey dey der.
JOS 8:25 Na 12,000 men and wimen die dat day, plus all di men for Ai.
JOS 8:26 Joshua still stresh en swod until Israel don kill evribody wey dey stay for Ai.
JOS 8:27 But Israel pipol keep all Ai tins and animals for demsef, just as God tell Joshua.
JOS 8:28 Joshua burn Ai and nobody fit stay der (na so e bi till today).
JOS 8:29 Joshua hang Ai king for tree kon leave am for der until evening. Wen sun don go down, Joshua kon tell di sojas sey make dem take di king dead body komot for di tree. Dem trow am put for di town gate kon pak stone on-top am (na so e bi till today).
JOS 8:30 Den Joshua build one altar for Israel God for Mount Ebal,
JOS 8:31 just as God savant Moses don kommand Israel pipol. As dem tok for di Law Book wey Moses rite, dem make am with stone wey dem nor kut or break or wey any iron don tosh. Dem burnt sakrifice for der kon do sakrifice for peace.
JOS 8:32 For Israel pipol present for der, Joshua kon rite Moses Law put for di stone.
JOS 8:33 Di pipol, rulers, leaders and judge dem stand for di two side for di box and for di Levi priests wey karry God Kovenant Box. Both Israel pipol and doz wey dey der as strenjas dey for di box front. Half of di pipol stand for Mount Gerizim front and di oda half stand for Mount Ebal front, just as God savant Moses kommand dem to do, before dem kollect di blessing.
JOS 8:34 Den Joshua read all di word for di law, plus di blessing and di curse, just as dem rite am for di Law Book.
JOS 8:35 Joshua read Moses kommand for all Israel pipol front, plus di wimen, shidren and strenjas wey dey stay with dem.
JOS 9:1 Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do,
JOS 9:2 dem kon join togeda won go fight against Joshua and Israel pipol.
JOS 9:3 Wen di pipol for Gibeon hear wetin Joshua do to Jeriko and Ai,
JOS 9:4 dem kon tink and do wetin dey wise. Dem kollect some food kon put tear-tear klot on-top dia donkey with wine bag wey don tear wey dem pash.
JOS 9:5 Dem wear sandal wey dem don pash kon wear tear-tear klot. All dia bread dry and strong.
JOS 9:6 Dem kom meet Joshua for di kamp for Gilgal kon tell en and di men for Israel sey, “Where wi from kom dey far well-well. Make una promise us sey una nor go kill us.”
JOS 9:7 Israel men kon tell Hiv men sey, “E fit bi sey una dey stay near us. So how wi go fit make promise with una?”
JOS 9:8 But dem kon tell Joshua, “Wi won bi yor savant.” So Joshua tell dem, “Na who una bi and where una from kom?”
JOS 9:9 Dem ansa, “Where yor savants from kom, far well-well and wi dey respet God, bikos wi don hear of all di tins wey E do for una for Egypt
JOS 9:10 and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.
JOS 9:11 Na awa leaders and pipol sey, ‘Make una take food for una journey go meet dem. Tell dem sey wi dey ready to bi dia savant. So make dem promise us sey dem nor go kill us.’
JOS 9:12 Awa bread dey warm wen wi start dis journey, but naw, e don dry kon strong.
JOS 9:13 Di wine bag get betta wine wen wi start di journey, but make una si how dem don skata finish. Awa klot and sandals don skata, bikos di journey long well-well.”
JOS 9:14 Di men for Israel look some of dia tins well-well, but dem forget to ask God sey wetin dem go do.
JOS 9:15 Joshua promise dem peace kon sey e nor go kill dem. Israel leaders sef agri wetin Joshua tok.
JOS 9:16 Three days afta dem agri with Gibeon pipol, Israel pipol kon know sey dem dey stay near dem.
JOS 9:17 So Israel pipol go and afta three days dem kon rish di town wey Gibeon, Kefirah, Beerot and Kiriat-Jearim pipol dey stay.
JOS 9:18 Israel pipol nor attack dem, bikos dia leaders don use Israel God name take swear sey dem nor go kill dem. Evribody kon dey vex for di leaders,
JOS 9:19 but di leaders kon tell di pipol sey, “Wi use Israel God take swear sey wi nor go kill dem. So naw, wi nor go fit kill dem!
JOS 9:20 Wi must let dem live, so dat wi nor go put curse for awa head.”
JOS 9:21 Di leaders still sey, “Make dem live.” So Gibeon pipol kon dey kut wood and karry wota for di whole kommunity, just as di leaders wont am.
JOS 9:22 Joshua koll Gibeon pipol kon tell dem, “Wetin make una deceive us wen una sey, ‘Where wi der stay, far from una,’ wen una really dey stay near us?
JOS 9:23 Naw, una go bi awa savants forever and una go dey kut wood and karry wota go awa God house.”
JOS 9:24 Dem kon tell Joshua, “Wi do like dis, bikos wi hear sey na really true sey di Oga una God don kommand Moses make e give una di whole land kon kill all di pipol wey dey stay der as una rish der. Wi do like dis, bikos wi dey fear una and wi nor won die.
JOS 9:25 So naw, wi dey under una. Make una do us wetin una tink sey dey good to do.”
JOS 9:26 Joshua kon do as dem tok; E nor let Israel pipol kill dem
JOS 9:27 and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.
JOS 10:1 Adoni-Zedek wey bi Jerusalem king hear how Joshua take enter Ai town kon distroy am and en king, just as e do to Jeriko and en king. E still hear how Gibeon pipol make peace with Israel pipol kon dey stay togeda.
JOS 10:2 Evribody for Jerusalem dey fear, bikos Gibeon na big town, like one of di kings town. E big pass Ai and all en men dem get pawa.
JOS 10:3 So king Adoni-Zedek for Jerusalem kon send message go meet King Hoham for Hebron, King Piram for Jarmut, King Jafia for Lakish and King Debir for Eglon:
JOS 10:4 sey, “Make una kom help mi go fight Gibeon, bikos e don go make peace with Joshua and Israel pipol.”
JOS 10:5 So di five kings wey kom from Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon, with all dia sojas kon gada go fight Gibeon pipol.
JOS 10:6 Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
JOS 10:7 So Joshua, en sojas and di ones wey get heart well-well kon from Gilgal mash go Gibeon.
JOS 10:8 God tell Joshua, “Make una nor fear, bikos I dey give dem to una. Non of dem go fit stop una.”
JOS 10:9 Joshua attack dem by sopraiz afta dem use one full nite mash kom from Gilgal.
JOS 10:10 God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.
JOS 10:11 As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.
JOS 10:12 Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”
JOS 10:13 Di sun and di moon stand for one place as Israel pipol kill all dia enemies. Dem rite dis tins wey happen for Jasha Book (wey mean Raitious Book). Di sun nor move for di sky centre and e shine for one full day.
JOS 10:14 Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
JOS 10:15 Den Joshua and Israel sojas kon go back to di kamp for Gilgal.
JOS 10:16 Di five king run go hide for one hole for Makkedah.
JOS 10:17 So dem tell Joshua, “Wi don si di five kings for di whole where dem hide put for Makkedah.”
JOS 10:18 Joshua ansa, “Make una use big stone kover di hole mout kon put pipol wey go guide am for der.
JOS 10:19 But make una nor stay tey! Make una porshu and katch una enemies! Nor let dem rish dia kountry, bikos di Oga una God go give dem to una.”
JOS 10:20 Joshua and Israel pipol almost kill dem finish, but some still eskape go di main town.
JOS 10:21 Den Israel sojas kom back well kom meet Joshua for di kamp for Makkedah. Nobody even fit tok against Israel pipol for di full land.
JOS 10:22 Joshua sey, “Make una open di hole, den bring di five kings kom meet mi.”
JOS 10:23 Dem do as Joshua tell dem kon take di five kings go meet am and na Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon king.
JOS 10:24 Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.
JOS 10:25 Den Joshua tell dem, “Make una nor fear or shake. Make una get heart and dey strong, bikos God go do di same tin to all una enemies wey una dey fight against.”
JOS 10:26 Den Joshua kill di kings kon hang dem on-top tree. Dem dey di tree till evening.
JOS 10:27 Wen sun don go down, Joshua kon sey make en men bring di kings body kom down from di tree kon trow dia body inside di hole wey dem hide put before, den pak big-big stones take kover di hole. (Dem still dey der till today.)
JOS 10:28 Dat day, Joshua enter Makkedah town kon kill evribody wey dey stay der plus di king. E do di king wetin e do to Jeriko king.
JOS 10:29 Joshua and Israel pipol kon mash from Makkedah go Libnah go fight dem.
JOS 10:30 God give Libnah to Joshua and en sojas and dem kill evribody wey dey stay der; evribody die finish. Dem kon do en king as dem do to Jeriko king.
JOS 10:31 Joshua and en sojas kon mash from Libnah go Lakish. En and en sojas kon fight against Lakish
JOS 10:32 and God make dem win and dem enter di whole town for di sekond day. Dem kill evribody wey dey stay der, just as dem do for Libnah.
JOS 10:33 Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.
JOS 10:34 Joshua and all Israel pipol mash from Lakish go Eglon. En and all en sojas kon fight dem.
JOS 10:35 Dat day, dem enter di town kon kill evribody wey dey stay der, den distroy am, just as dem do to Lakish.
JOS 10:36 Joshua and all en sojas mash from Eglon go Hebron go fight.
JOS 10:37 Dem enter di town kon kill di king, evribody wey dey stay der and di towns wey dey near der and dem nor leave anybody. Dem kill evribody, just as dem do for Eglon.
JOS 10:38 Joshua and en sojas kon go fight against Debir.
JOS 10:39 Dem enter di town, katch di king and all di towns wey dey near am, den dem kill evribody wey dey stay der; nobody survive. Dem kill evribody, just as dem do for Hebron, Libnah and to dia kings.
JOS 10:40 Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
JOS 10:41 Joshua win di aria wey dey between Kadesh Barnea and Gaza, plus evriwhere for Goshen go rish Gibeon.
JOS 10:42 Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.
JOS 10:43 Den Joshua and all en sojas kon go back to dia kamp for Gilgal.
JOS 11:1 Wen King Jabin for Hazor hear di news, e send message go meet King Jobab for Madon; Shimron king, Akshaf king
JOS 11:2 and all di kings for nort wey dey rule di kountries for hill, di Arabah for di sout for Kinneret, di ones for di lowland and doz ones for Dor wey dey di west,
JOS 11:3 Kanaan pipol from di east and west; Amor, Hit, Periz and Jebus pipol from di kountry for hill and Hiv pipol from under Hermon for di aria wey dey Mizpa.
JOS 11:4 All dis kings kom out with dia sojas and nobody fit kount dem, bikos dem many like san-san for wotaside and dia shariot many well-well too.
JOS 11:5 All dis kings gada for Merom River side, bikos dem won fight Israel pipol.
JOS 11:6 God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”
JOS 11:7 So Joshua and all en sojas attack dem for Merom River side wen dem nor know sey dem dey kom.
JOS 11:8 God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish.
JOS 11:9 Joshua do dem, just as God kommand; e cripple dia horse leg kon burn dia shariot.
JOS 11:10 For dat time, Joshua attack Hazor town kon kill en king, bikos na Hazor town dey lead all di kingdoms.
JOS 11:11 Dem kill evribody wey dey stay der kon burn di town.
JOS 11:12 Joshua enter all di royal towns kon kill dia kings, just as God savant, Moses kommand dem.
JOS 11:13 But Israel pipol nor burn any town wey dey di hill, escept Hazor wey Joshua burn.
JOS 11:14 Israel pipol karry evritin wey dey dis towns, plus dia animals, but dem kill all dia pipol finish.
JOS 11:15 God savant, Moses, tell Joshua evritin wey God kommand and Joshua do as Moses tell am. E nor go against any of di kommand wey God tell Moses.
JOS 11:16 Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands,
JOS 11:17 from Mount Halak to Seir go rish Baal-Gad for Lebanon Valley under Mount Hermon. Joshua katch all dia kings kon kill dem.
JOS 11:18 Joshua fight against dis kings for sometaim.
JOS 11:19 No town make peace with Israel pipol (escept Hiv pipol wey dey stay for Gibeon.) Israel pipol win all di remainin towns,
JOS 11:20 bikos God make di towns sturbon, so dat dem go attack Israel. God wont make Israel pipol kill dem anyhow, just as E don kommand Moses.
JOS 11:21 For dat time, Joshua attack and kill Anak pipol for di hill kountry, Hebron, Debir and Anab from all di hill kountry for Judah and Israel.
JOS 11:22 No Anak pesin remain among Israel pipol, but some dey for Gaza, Gat and Ashdod.
JOS 11:23 Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.
JOS 12:1 Di kings wey Israel pipol win and take dia land for Jordan River east and from Arnon Valley go Mount Hermon, plus Arabah east na:
JOS 12:2 King Sihon for Amor wey dey stay Heshbon and dey rule from Aroer (wey dey Arnon Valley korna), plus di town wey dey di valley centre and half of Gilead go rish Jabbok Valley wey dey near Ammon.
JOS 12:3 En kingdom na: Arabah east, from Kinneret Sea go rish Arabah Sea (Di Salt Sea), plus di road wey go Bet-Jeshimot and di sout aria under di low aria for Pisgah.
JOS 12:4 E win King Og for Bashan wey dey among di remainin Refah pipol and e dey stay for Ashtarot and Edrei.
JOS 12:5 Na-im dey rule Mount Hermon, Salekah, evriwhere for Bashan go rish Geshur, Maakat, half of Ramot pipol borda and King Sihon for Heshbon borda.
JOS 12:6 God savant, Moses and Israel pipol win dis kings and Moses divide di land give Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.
JOS 12:7 Dis na di kings wey Joshua and Israel pipol win for Jordan River west, from Baal-Gad for Lebanon Valley go rish Mount Halak and Seir. Joshua give dis aria to Israel tribes,
JOS 12:8 plus di kountries for hill, di lowlands, di Arabah, di low groun, di wildaness and di Negev; Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol land. Dis na di kings:
JOS 12:9 Jeriko king, Ai king (wey dey near Bethel),
JOS 12:10 Jerusalem king, Hebron king,
JOS 12:11 Jarmut king, Lakish king,
JOS 12:12 Eglon king, Geza king,
JOS 12:13 Debir king, Geda king,
JOS 12:14 Hormah king, Arad king,
JOS 12:15 Libnah king, Adullam king,
JOS 12:16 Makkedah king, Bethel king,
JOS 12:17 Tappuah king, Hefa king,
JOS 12:18 Afek king, Sharon king,
JOS 12:19 Madon king, Hazor king,
JOS 12:20 Shimron Meron king, Akshaf king,
JOS 12:21 Taanak king, Megiddo king,
JOS 12:22 Kedesh king, Jokneam king wey dey near Karmel,
JOS 12:23 Dor king (for Nafat Dor), Goyim king (for Gilgal) and
JOS 12:24 Tirzah king. So all di kings na thirty-one.
JOS 13:1 Wen Joshua don old, God kon tell am, “Yu don old and di land wey una go still fight for, many well-well
JOS 13:2 and dem bi: Filistia pipol and Geshur aria,
JOS 13:3 from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land
JOS 13:4 go rish di sout; all di aria wey bi Kanaan own; from Arah wey dey Sidon go rish Afek and Amor pipol aria;
JOS 13:5 Gebal pipol aria and evriwhere for Lebanon for di east. From Baal-Gad; bottom Mount Hermon go rish Lebo-Hamat.
JOS 13:6 “I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.
JOS 13:7 Naw, make yu divide dis land among di nine and half tribes.”
JOS 13:8 Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.
JOS 13:9 Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon
JOS 13:10 and all di town wey Sihon king for Amor wey dey rule Heshbon get, go rish di borda.
JOS 13:11 Dia aria na Gilead, Geshur and Maakat, plus evriwhere for Mount Hermon and Bashan go rish Salekah.
JOS 13:12 And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land.
JOS 13:13 But Israel pipol nor distroy Geshur and Maakat; So Geshur and Maaka pipol dey stay with dem till today.
JOS 13:14 But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
JOS 13:15 Moses divide land give Reuben tribe akordin to dia family.
JOS 13:16 Dia aria start from Aroer (wey dey near Arnon Valley) plus di town wey dey di valley centre, evriwhere for Medeba,
JOS 13:17 Heshbon and all di towns wey dey near am; plus Dibon, Bamot Baal, Bet-Baal-Meon,
JOS 13:18 Jahza, Kedemot, Mefaat,
JOS 13:19 Kiriataim, Sibmah, Zeret Shahar wey dey on-top di hill for di valley,
JOS 13:20 Bet-Peor, di low land for Pisgah and Bet-Jeshimot.
JOS 13:21 Dis na all di towns for di aria plus di ones wey King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon, get. Moses win en and Midian leaders wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba (all of dem dey under King Sihon).
JOS 13:22 Israel pipol kill Balaam (wey bi profet) wey Beor born.
JOS 13:23 Na Reuben tribe get di borda for Jordan River. Di towns and village dey join di land wey dem give Reuben tribe.
JOS 13:24 Moses divide land give Gad tribe akordin to dia family.
JOS 13:25 Na dia aria bi dis: Jazer aria, all di town for Gilead and half of Ammon aria go rish Aroer near Rabbah.
JOS 13:26 And from Heshbon go rish Ramat-Mizpah and Betonim. From Mahanaim go rish Debir aria.
JOS 13:27 Bet-Haram valley still dey join, plus Bet-Nimrah, Sukkot and Zafon go rish di rest side for Heshbon wey King Sihon dey rule; plus di aria for Jordan River east go rish di end for Kinneret Sea.
JOS 13:28 Na dis towns bi di land wey dem divide give Gad tribe akordin to dia family.
JOS 13:29 Moses divide land give half of Manasseh tribe akordin to dia family.
JOS 13:30 Dia land start from Mahanaim go rish Bashan; di whole aria where King Og for Bashan dey rule, plus di sixty towns for Havvot-Jair.
JOS 13:31 Di land wey dem give half of Makir shidren wey Manasseh bi dia grand-grand papa na: half for Gilead land, Ashtarot and Edrei and King Og for Bashan kingdom and na akordin to dia family.
JOS 13:32 Na so Moses sey make dem take divide di land wen e dey Moab for Jordan River east opposite Jeriko.
JOS 13:33 Moses nor divide land as propaty for Levi tribe; dia propaty na di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
JOS 14:1 Dis na di aria wey priest Eleazar, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders give Israel pipol for Kanaan land.
JOS 14:2 Di land wey dem give di nine and half tribe, na dice dem trow take divide am, just as God tell Moses.
JOS 14:3 Naw, di land wey dey east for Jordan River, Moses divide am give two and di half tribe, but e nor divide any land give Levi pipol.
JOS 14:4 Dem si Josef shidren as two tribe, Manasseh and Efraim. Dem nor give Levi pipol any land; aldo dem give dem towns where dem go stay, plus fields where dia animals go for dey chop.
JOS 14:5 Wen dem dey divide di land, Israel pipol do as God tell Moses.
JOS 14:6 Judah men kom meet Joshua for Gilgal and Kaleb wey Jefunneh wey kom from Kenizz born kon tell Joshua sey, “Yu know wetin God tell Moses en savant for Kadesh Barnea about yu and mi.
JOS 14:7 I bi forty years wen Moses, God savant send mi from Kadesh Barnea go spy di land and I kom back kon tell am di trut.
JOS 14:8 Doz wey follow mi kon dey make Israel pipol fear, but I still dey loyal to di Oga my God.
JOS 14:9 Dat day, Moses kon promise mi, ‘Any land wey yu waka enter, go bi yu and yor family own forever, bikos yu dey loyal to di Oga yor God.’
JOS 14:10 “So naw, make yu si, God don keep mi rish naw, just as E promise. For dis forty-five years, even since God tell Moses en word wen Israel pipol still dey di wildaness kom rish naw, I nor die and naw, I bi eighty-five years.
JOS 14:11 Yet, I still strong like wen Moses send mi go spy. I fit still fight kon do my evriday work with di same pawa wey I get dat time.
JOS 14:12 So make yu give mi di kountry for hill wey God promise mi dat time! Dat time, yu know sey na Anak pipol dey der with dia big-big towns. But if God dey with mi, I go distroy dem, as God promise.”
JOS 14:13 Den Joshua bless Kaleb, Jefunneh pikin kon give Hebron land to am.
JOS 14:14 So till today, Kaleb wey en papa na Jefunneh from Kenizz kon take Hebron land, bikos e dey loyal to God.
JOS 14:15 (Before-before, dem dey koll Hebron, Kiriat-Arba. Na Arba bi Anak pipol papa and evribody know am.) So afta dis time, war nor kon dey di land again.
JOS 15:1 Di land wey dem give Judah tribe akordin to dia family, long from Edom borda go rish Zin Wildaness for Negev wey dey sout.
JOS 15:2 Dia borda for sout start from di sout-side for di Salt Sea
JOS 15:3 go rish Akrabbim Ascent sout kon cross go Zin, till e rish Kadesh Barnea sout kon cross from der go Hezron on-top Addar and e kom down for Karka.
JOS 15:4 Di land cross go Azmon, till e rish Egypt wotaside kon end for di sea. Na dis bi di borda for sout.
JOS 15:5 Di borda for east na from di Salt Sea go rish Jordan River. Di borda for nort start from di Salt Sea from Jordan River mout
JOS 15:6 go rish Bet-Hoglah, den cross di nort for Bet-Arabah go di Stone wey bi Reuben pikin, Bohan own.
JOS 15:7 E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel.
JOS 15:8 E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort.
JOS 15:9 E from der go on-top di hill go rish di spring wota for Neftoah, plus di whole town for Mount Efron, den from Mount Efron to Baalah (wey bi Kiriat-Jearim).
JOS 15:10 E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah.
JOS 15:11 E still from der go Ekron lowland for nort till e rish Shikkeron, den cross go Mount Baalah, till e rish Jabneel kon end for di sea.
JOS 15:12 Na Mediterranean Sea bi di borda for west. And na dis bi di borda for Judah tribe and family.
JOS 15:13 Kaleb wey bi Jefunneh son from Judah tribe, dem gi-am Kiriat-Arba (wey bi Hebron), just as God tell Joshua. (Na Arba bi Anak papa.)
JOS 15:14 From der, Kaleb porshu Sheshai, Ahiman and Talmai wey bi Anak shidren
JOS 15:15 kon attack Debir pipol. (Before-before, dem dey koll Debir pipol Kiriat-Sefer.)
JOS 15:16 Kaleb kon sey, “Di pesin wey go win Kiriat-Sefer, I go gi-am my dota Aksah, as en wife.”
JOS 15:17 Wen Otniel, Kenaz pikin wey bi Kaleb broda win am, Kaleb kon give en dota, Aksah to am as wife.
JOS 15:18 One day Otniel kom meet and beg Aksah make e ask en papa for some land. Wen e kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont.”
JOS 15:19 E ansa, “Abeg, make yu give mi one special gift. Since yu don give mi land for Negev aria, make yu give mi spring wota.” So en papa kon gi-am both di spring for up and di one for bottom.
JOS 15:20 Dis na di land wey dem give Judah tribe and dia family:
JOS 15:21 Dis towns dey Judah land end for sout near Edom borda and dem bi: Kabzeel, Eda, Jagur,
JOS 15:22 Kinah, Dimonah, Adadah,
JOS 15:23 Kedesh, Hazor, Itnan,
JOS 15:24 Zif, Telem, Bealot,
JOS 15:25 Hazor-Hadattah, Keriot Hezron (wey bi Hazor),
JOS 15:26 Amam, Shema, Moladah,
JOS 15:27 Hazar-Gaddah, Heshbon, Bet-Pelet,
JOS 15:28 Hazar-Shual, Beersheba, Biziotaya,
JOS 15:29 Baalah Lim, Ezem,
JOS 15:30 Eltolad, Kesil, Hormah,
JOS 15:31 Ziklag, Madmanna, Sansannah,
JOS 15:32 Lebaot, Shilhim, Ain, Rimmon and dem bi twenty-nine big and small towns.
JOS 15:33 Dis na di towns wey dey di lowland: Eshtaol, Zorah, Ashnah,
JOS 15:34 Zanoah, En-Gannim, Tappuah, Enam,
JOS 15:35 Jarmut, Adullam, Soko, Azeka,
JOS 15:36 Shaaraim, Aditaim and Gederah (or Gederotaim) and dem bi fourteen big and small towns.
JOS 15:37 Zenan, Hadashah, Migdal-Gad,
JOS 15:38 Dilean, Mizpa, Jokteel,
JOS 15:39 Lakish, Bozgat, Eglon,
JOS 15:40 Kabbon, Lahmas, Kitlish
JOS 15:41 Gederot, Bet-Dagon, Naamah and Makkedah and dem bi sixteen big and small towns.
JOS 15:42 Libnah, Eta, Ashan,
JOS 15:43 Jeftah, Ashnah, Nezib,
JOS 15:44 Keilah Akzib and Maresha and dem bi nine big and small towns.
JOS 15:45 Ekron and all di towns wey dey near am;
JOS 15:46 from Ekron west, evribody for Ashdod aria and dia towns;
JOS 15:47 Ashdod and doz wey dey near am, plus Gaza with doz wey dey near am, go rish Egypt Stream and di borda for Mediterranean Sea.
JOS 15:48 Dis na di towns for di kountries for hill: Shamir, Jattir, Sokoh,
JOS 15:49 Dannah, Kiriat-Sannah (wey bi Debir),
JOS 15:50 Anab, Eshtemoh, Anim,
JOS 15:51 Goshen, Holon and Gilo and dem bi eleven big and small towns.
JOS 15:52 Arab, Dumah, Eshan,
JOS 15:53 Janim, Bet-Tappuah, Afeka,
JOS 15:54 Humtah, Kiriat-Arba (wey bi Hebron) and Zior and dem bi nine big and small towns.
JOS 15:55 Maon, Karmel, Zif, Juttah,
JOS 15:56 Jezrel, Jokdeam, Zanoah,
JOS 15:57 Kain, Gibeah and Timnah and dem bi ten big and small towns.
JOS 15:58 Halhul, Bet-Zur, Gedor,
JOS 15:59 Maarat, Bet-Anot and Eltekon and dem bi six big and small towns.
JOS 15:60 Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim) and Rabbah and dem bi two towns.
JOS 15:61 Dis na di towns for desert: Bet-Arabah, Middin, Sekakah,
JOS 15:62 Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns.
JOS 15:63 Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
JOS 16:1 Di land wey Joshua give Josef shidren na from Jordan River side go rish di wotaside for Jeriko east; den to di desert and from Jeriko go di kountry for di hill wey bi Bethel.
JOS 16:2 Di borda for sout wey from Bethel go Luz kon cross go Arkite aria for Atarot.
JOS 16:3 E from der go di west side for Jafletite aria and di low arias for Bet-Horon and Geza kon end for di sea.
JOS 16:4 Dem give Josef shidren, Manasseh and Efraim dia own part for di land.
JOS 16:5 Di aria wey dem give Efraim and en family na: di east for Atarot-Addar go rish top of Bet-Horon.
JOS 16:6 E from der go di sea and Mikmetat for di nort. E still from der go di east side for Taanat-Shiloh kon cross go Janoah east.
JOS 16:7 E from Janoah go Atarot and Naarah kon tosh Jeriko till e rish Jordan River.
JOS 16:8 From Tappuah, e go di west side for Kanah Valley den e end for di sea. Dis na di land wey Joshua give Efraim tribe akordin to en family.
JOS 16:9 Di big and small towns wey dem keep for Efraim family inside Manasseh aria dey join.
JOS 16:10 Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.
JOS 17:1 Josef first-born, Manasseh, dem give en tribe some land too. Manasseh first-born Makir wey bi Gilead papa, dem gi-am land, bikos dem bi wariors. Dem give dem Gilead and Bashan.
JOS 17:2 Di rest for Manasseh shidren, dem give dem land akordin to dia family plus Abiezer, Helek, Asriel, Shekem, Hefa and Shemida shidren. Dis na di boys wey Manasseh, Josef pikin born akordin to dia family.
JOS 17:3 Naw, Zelofehad wey bi Hefa son, wey bi Gilead son and na Manasseh pikin wey Makir born, nor get any boy pikin escept girls and dia names na: Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
JOS 17:4 Di girls go meet Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and di leaders kon sey, “God tell Moses sey make e give us land among awa pipol.” So, Joshua give dem land among dia papa brodas, just as God kommand.
JOS 17:5 Dem give Manasseh ten share for di land join di ones wey e get for Gilead and Bashan wey dey Jordan River east
JOS 17:6 and dem give Manasseh dotas some land among dia brodas. Di rest for Manasseh shidren, na dem get di lands for Gilead.
JOS 17:7 Manasseh borda na from Asher go Mikmetat wey dey near Shekem. From der, e from sout face doz wey dey stay Tappuah.
JOS 17:8 (Na Manasseh get di land dem wey surround Tappuah, but Tappuah main town, na Efraim get am.)
JOS 17:9 Di borda na from sout go Kanah Valley. Dem give Efraim pipol some town among Manasseh towns, but Manasseh borda na nort for di valley and e end for di sea.
JOS 17:10 Efraim aria na for sout, while Manasseh own na for nort. Di sea na Manasseh borda for west and dia aria tosh Asher for nort and Issakar for east.
JOS 17:11 Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.
JOS 17:12 But di men for Manasseh nor fit win dis towns and Kanaan pipol still dey di aria with dem.
JOS 17:13 So Israel pipol pawa kon strong well-well pass Kanaan pipol own for dat aria, so dem kon force Kanaan pipol to bi dia slave, but dem nor fit win dem finish.
JOS 17:14 Josef shidren kon tell Joshua, “Wetin make yu give us only one part for di land? Wi many well-well, bikos God don bless us.”
JOS 17:15 Joshua ansa dem, “If una many well-well and di kountries for hill too small for una, den make una go inside di forest kon klear Periz and Refah land for unasef.”
JOS 17:16 Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”
JOS 17:17 Joshua kon tell Josef family wey bi Efraim and Manasseh sey: “Una get many pipol and betta sojas wey get pawa. Una go get pass one share.
JOS 17:18 Di whole kountry for di hill go bi una own; even doh na forest, una fit klear and take am. Una fit distroy Kanaan pipol for der, aldo dem get strong shariot well-well.”
JOS 18:1 Israel pipol gada for Shiloh and dem kon build di tent where dem for dey meet, for der. Aldo dem don win di land,
JOS 18:2 dem neva still give seven tribe for Israel dia own share for di land.
JOS 18:3 So Joshua tell Israel pipol: “Na how many years una won wait before una start to stay all dis land wey una Oga God for Israel don give una?
JOS 18:4 Make una selet three-three men from each tribe. I go ask dem make dem waka round di land kon draw di map for mi.
JOS 18:5 Den I go divide am into seven. Judah go stay for di sout-side and Josef family go dey nort.
JOS 18:6 But as for una, make una divide di land into seven, den bring am kom meet mi. I go trow dice before di Oga awa God.
JOS 18:7 But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”
JOS 18:8 Wen di men kom out, Joshua kon tell doz wey dey go look di land sey, “Make una go waka round di land kon put am for map, den una go kom back kom meet mi, so dat I go trow dice for una for God present as wi dey Shiloh.”
JOS 18:9 Di men waka round di land kon divide am into seven for di book. Den dem kom back kom meet Joshua for di kamp for Shiloh.
JOS 18:10 For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.
JOS 18:11 Di first dice wey Joshua trow na for Benjamin tribe akordin to dia family. Dia land na between Judah and Josef tribe.
JOS 18:12 Di borda for nort start for Jordan River go rish Jeriko for nort, den e go di west side for di hill kountry go rish di desert for Bet-Aven.
JOS 18:13 E cross from der go Luz kon go di sout for Luz (wey bi Bethel), den e go Atarot-Addar for di hill wey dey sout for di low side for Bet-Horon.
JOS 18:14 E turn from di west side face sout from di hill wey dey near Bet-Horon for di sout till e rish Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim), di town wey bi Judah tribe own. Dis na di borda for west.
JOS 18:15 Di sout-side start for Kiriat-Jearim kon go west for Neftoah wotaside.
JOS 18:16 Di borda go di hill kountry near Ben-Hinnom Valley wey dey Refah Valley for nort. E from Hinnom Valley go di low land for Jebus aria for sout, den kon go En-Rogel.
JOS 18:17 E go En-Shemesh nort and Gelilot opposite Adummim Pass, den kon go Reuben pikin, Bohan Stone.
JOS 18:18 E from der cross go di lowland for front of Arabah for nort go rish di main Arabah.
JOS 18:19 E cross go di lowland for Bet-Hoglah for nort kon end for di nort side for di Salt Sea for Jordan River side. Dis na di borda for sout.
JOS 18:20 Jordan River borda dey for east. Dis na di borda for di land wey dem give Benjamin tribe and en family.
JOS 18:21 Dis na di towns wey bilong to Benjamin tribe and family: Jeriko, Bet-Hoglah, Emek-Kezizz,
JOS 18:22 Bet-Arabah, Zemaraim, Bethel,
JOS 18:23 Avvim, Parah, Ofrah,
JOS 18:24 Kefar Ammoni, Ofni and Gibeah. Dem bi twelf big and small-small towns.
JOS 18:25 Gibeon, Rama, Beerot,
JOS 18:26 Mizpa, Kefirah, Mozah,
JOS 18:27 Rekem, Irpeel, Taralah,
JOS 18:28 Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town. All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.
JOS 19:1 Di sekond koin wey Joshua trow na for Simeon tribe and family.
JOS 19:2 Dia land na Beersheba, Moladah,
JOS 19:3 Hazar-Shual, Balah, Ezem,
JOS 19:4 Eltolad, Betul, Hormah,
JOS 19:5 Ziklag, Bet-Marcabot, Hazar-Susah,
JOS 19:6 Bet-Lebaot and Sharuhen. Dem bi thirteen big and small town.
JOS 19:7 Ain, Rimmon, Eta and Ashan. Dem bi four big and small town,
JOS 19:8 plus all di towns wey rish Baalat Beer (Rama for Negev). Dis na di land wey Joshua give Simeon akordin to en family.
JOS 19:9 Dem give Simeon land from di ones wey dem give Judah, bikos Judah aria too big for dem.
JOS 19:10 Di third koin wey Joshua trow na for Zebulun tribe and family. Di borda for dia aria rish Sarid.
JOS 19:11 Di borda from west go Maralah kon tosh Dabbeshet and di valley wey dey near Jokneam.
JOS 19:12 From Sarid, e turn face di east for Kislot-Tabor aria kon go Daberat and from der go Jafia.
JOS 19:13 From der e cross go east for Gat-Hefa and Et-Kazin aria go rish Rimmon kon turn go Neah.
JOS 19:14 E turn from nort go Hannaton till e end for Jeftah-El Valley.
JOS 19:15 Dia aria na Kattah, Nahalal, Shimron, Idalah and Betlehem and all of dem na twelf big and small towns.
JOS 19:16 All dis na di land wey dem give Zebulun tribe and dia family, plus di big and small towns.
JOS 19:17 Di fourt koin wey Joshua trow na for Issakar tribe and family.
JOS 19:18 Dia land na Jezrel, Kesullot, Shunem,
JOS 19:19 Hafaraim, Shion, Anaharat,
JOS 19:20 Rabbit, Kishon, Ebez,
JOS 19:21 Remet, En-Gannim, En-Haddah and Bet-Pazez.
JOS 19:22 Dia borda tosh Tabor, Shahazumah and Bet-Shemesh kon end for Jordan River. Dem get sixteen big and small town.
JOS 19:23 All dis na di land wey dem give Issakar tribe and dia family, plus di big and small town.
JOS 19:24 Di fift koin wey Joshua trow na for Asher tribe and family.
JOS 19:25 Dia land na Helkat, Hali, Beten, Akshaf,
JOS 19:26 Alammelek, Amad and Mishal. Dia borda tosh Karmel for west and Shihor-Libnat.
JOS 19:27 E turn go east kon face Bet-Dagon den tosh Zebulun and Jeftah-El Valley for nort, e still tosh Emek and Neiel Valley kon go Kabul for nort
JOS 19:28 till e rish Abdon, Ebron, Rehob, Hammon and Kanah and Greata Sidon.
JOS 19:29 E turn face Rama plus di strong-strong towns for Tyre, den e turn face Hosah kon end for di sea near Hebel, Akzib,
JOS 19:30 Umah, Afek and Rehob. Dem get twenty-two big and small towns.
JOS 19:31 All dis na di land wey dem give Asher tribe and dia family, plus di big and small town.
JOS 19:32 Di sixt koin wey Joshua trow na for Naftali tribe and family.
JOS 19:33 Dia borda start from Helef and Zaanannim oak kon go Adami-Nekeb, Jabneel until e rish Lakkum kon end for Jordan River.
JOS 19:34 E from der turn face west for Aznot-Tabor till e rish Hukok kon tosh Zebulun for di sout. Asher dey for en west and Jordan River for en east.
JOS 19:35 Di strong towns na Ziddim, Zer, Hamat, Rakkat, Kinneret,
JOS 19:36 Adamah, Rama, Hazor,
JOS 19:37 Kedesh, Edrei, En-Hazor,
JOS 19:38 Yiron, Migdal-El, Horem, Bet-Anat and Bet-Shemesh. Dem get nineteen big and small town.
JOS 19:39 All dis na di land wey dem give Naftali tribe and dia family, plus di big and small town.
JOS 19:40 Di sevent koin wey Joshua trow na for Dan tribe and family.
JOS 19:41 Dia land na Zorah, Eshtaol, Ir Shemesh,
JOS 19:42 Shaalabbin, Aijalon, Itlah,
JOS 19:43 Elon, Timnah, Ekron,
JOS 19:44 Eltekeh, Gibbeton, Baalat,
JOS 19:45 Jehud, Bene-Berak, Gat-Rimmon,
JOS 19:46 Jarkon wotaside and Rakkon plus di aria for Joppa front.
JOS 19:47 (Dan pipol nor fit win all dia aria, so dem kon go fight and win Leshem. Dem kill evritin for der kon bigin stay der. Dem kon name am, “Dan” wey bi dia grand-grand papa name.)
JOS 19:48 All dis na di land wey dem give Dan tribe and dia family, plus di big and small town.
JOS 19:49 Wen dem don divide di land into seven, Israel pipol kon give Joshua, Nun pikin some land.
JOS 19:50 As God tok, dem kon give Joshua di town wey e ask for, wey bi, Timnat-Serah for Efraim hill kountry. So Joshua build di town kon bigin stay der.
JOS 19:51 Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders, na dis bi di whole land wey dem divide and dem rite am for book kon put am for Shiloh for God present. So, dem kon divide di land finish.
JOS 20:1 God kon tell Joshua:
JOS 20:2 “Israel pipol don selet di towns wey pesin go for dey save and I tell yu dis tin thru Moses.
JOS 20:3 Anybody wey by mistake kill pesin, fit run go der from di man wey go won kill-am.
JOS 20:4 “E fit run go one of dis towns kon go di judgement place for di town gate, den judge wetin happen give di leaders for der. Di leaders go take am enter di town kon gi-am where e go stay.
JOS 20:5 Wen di pesin wey won take revensh find am kom, dem nor go let am attack di man, bikos na mistake e take kill di pesin.
JOS 20:6 E go stay di town until dem go judge en kase for di kounsol or wen di High Priest don die. Den e fit go back to di town wey e from kom.”
JOS 20:7 So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.
JOS 20:8 Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe.
JOS 20:9 Dis na di towns wey dem give all Israel pipol and doz wey dey stay with dem. Wen pesin kill anoda pesin by mistake, e fit run go der and who won kill-am nor go fit kill-am again, until di eldas judge en kase.
JOS 21:1 Di leaders for Levi tribe go meet Eleazar wey bi priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders
JOS 21:2 for Shiloh wey dey Kanaan land kon sey, “God tell Moses sey make e give us town wey wi go stay and fields for awa animals.”
JOS 21:3 So Israel pipol give Levi tribe towns and fields from dia own, just as God don tok.
JOS 21:4 Dem share di first ones give Kohat family. Di Levi wey bi priest Aaron shidren kon get thirteen big towns from Judah, Simeon and Benjamin tribe.
JOS 21:5 Di rest for Kohat shidren get ten big towns from Efraim, Dan and half of Manasseh tribe.
JOS 21:6 Gershon shidren get thirteen big towns from Issakar, Asher, Naftali and half of Manasseh tribe wey dey Bashan.
JOS 21:7 Merari shidren and dia family get twelf big towns from Reuben, Gad and Zebulun tribe.
JOS 21:8 So Israel pipol give Levi tribe dia towns and fields, just as God tell Moses.
JOS 21:9 From Judah and Simeon tribe, na di towns wey dem give out bi dis.
JOS 21:10 Dem give Kohat family from Levi tribe wey bi Aaron shidren, bikos di first share na en own.
JOS 21:11 Dem give dem Kiriat-Arba (na Arba bi Anak papa), wey bi Hebron for di hill kountry for Judah, plus di aria wey dey near am.
JOS 21:12 (Dem give di fields and di towns wey dey near am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.)
JOS 21:13 So for Aaron shidren, di priest kon give dem Hebron (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Libnah,
JOS 21:14 Jattir, Eshtemoa,
JOS 21:15 Holon, Debir,
JOS 21:16 Ain, Juttah and Bet-Shemesh, plus all di aria for der.
JOS 21:17 From Benjamin tribe, dem give dem Gibeon, Gibeah,
JOS 21:18 Anatot and Almon, plus di aria wey dey near der and all of dem na four towns.
JOS 21:19 Di priests wey kom from Aaron family kon get thirteen towns, plus di aria for der.
JOS 21:20 Di rest for Kohat family for Levi tribe kon get big towns from Efraim tribe and dem bi:
JOS 21:21 Shekem (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) wey dey Efraim kountry for di hill, Geza,
JOS 21:22 Kibzaim and Bet-Horon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:23 From Dan tribe, dem give dem Eltekeh, Gibbeton,
JOS 21:24 Aijalon and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:25 From half of Manasseh tribe, dem give dem Taanak and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi two big towns.
JOS 21:26 Di rest for Kohat family get ten towns and dia aria.
JOS 21:27 Dem give Gershon family for Levi tribe dis towns: from half of Manasseh tribe, dem give dem Golan for Bashan (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) with Beeshtarah, all di aria for der and dem bi two big towns.
JOS 21:28 From Issakar tribe, dem give dem: Kishon, Daberat,
JOS 21:29 Jarmut and En-Gannim, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:30 From Asher tribe, dem give dem: Mishal, Abdon,
JOS 21:31 Helkat and Rehob, plus di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:32 From Naftali tribe, dem give dem: Kedesh for Galilee (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Hammot-Dor and Kartan, plus all di aria for der and dem bi three big towns.
JOS 21:33 Gershon family get thirteen towns and dia aria.
JOS 21:34 Dis na di towns wey dem give Merari family (doz wey remain for Levi tribe). From Zebulun tribe, dem give dem: Jokneam, Kartah,
JOS 21:35 Dimnah and Nahalal, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:36 From Reuben tribe, dem give dem: Beza, Jahza,
JOS 21:37 Kedemot and Mefaat, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:38 From Gad tribe, dem give dem: Ramot for Gilead (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Mahanaim,
JOS 21:39 Heshbon and Jazer, plus di aria for der and dem bi four big towns.
JOS 21:40 Merari family (doz wey remain for Levi tribe) kon get twelf big towns.
JOS 21:41 Levi tribe kon get forty-eight big towns plus dia aria among di land wey bi Israel pipol own.
JOS 21:42 All dis towns get betta aria round am and dem resemble well-well.
JOS 21:43 So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der.
JOS 21:44 God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem.
JOS 21:45 So, God do evritin wey E promise Israel pipol.
JOS 22:1 Den Joshua koll Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe
JOS 22:2 kon tell dem: “Una don do evritin wey God savant Moses tell una kon obey evritin wey I tell una.
JOS 22:3 All dis time, una neva leave una pipol and una always dey obey di Oga wey bi una God.
JOS 22:4 Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.
JOS 22:5 But make una dey obey God kommand and laws wey en savant Moses tell una with kare; make una dey loyal to am kon serve am with all una heart and body!”
JOS 22:6 Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house.
JOS 22:7 (Naw, Moses give Bashan land to half of Manasseh tribe and Joshua kon give Jordan River west to di oda half for Manasseh tribe and Israel pipol wey dey with dem.) Wen Joshua sey make dem dey go house, e give dem gift
JOS 22:8 kon sey, “Make una take dis tin dey go and dem bi plenty money, many-many animals, silva, gold, bronze, iron and many klot. Di tins wey wi karry from awa enemies, make una divide am among unasef.”
JOS 22:9 So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.
JOS 22:10 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe rish Gelilot near Jordan River for Kanaan land kon build one fine altar for der.
JOS 22:11 Israel pipol hear wetin happen sey: “Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe don build one altar for di town door-mot for Gelilot wey dey Kanaan near Jordan River for di oda side wey Israel pipol dey.”
JOS 22:12 Wen Israel pipol hear wetin happen, dem kon gada for one place for Shiloh to go fight dem.
JOS 22:13 Israel pipol send Finehas, wey bi Eleazar di priest son go Gilead go meet Reuben and Gad pipol plus half of Manasseh tribe.
JOS 22:14 Ten leaders follow am go, one from each tribe, dem bi leaders for Israel family.
JOS 22:15 Dem kon go Gilead land go meet Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem:
JOS 22:16 “Evribody for Israel wey bi God own sey make wi ask una, ‘Wetin make una disobey Israel God as una don turn from am.
JOS 22:17 Di sin wey wi sin for Peor nor bad rish? Till today wi neva fit klean awasef finish; e even bring wahala kom meet us wey bi God pipol.
JOS 22:18 Naw, today, una don turn una back to di Oga una God! “ ‘Today wey una dey fight against God so; E fit kon vex for di whole Israel pipol.
JOS 22:19 But if una land nor dey okay bikos of sin, una fit cross kom meet us for di land where God dey. But make una nor build altar for unasef wey nor bi awa Oga God altar, bikos dat go show sey una dey fight against God and wi.
JOS 22:20 Wen Zera pikin, Akan nor gri obey di kommand about di town tins, na di whole town sofa am, even doh na only one man sin. And nor bi only en die for di sin wey e kommit.’ ”
JOS 22:21 Den Reuben and Gad pipol and half of Manasseh tribe kon ansa Israel leaders sey:
JOS 22:22 “Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today!
JOS 22:23 If wi build altar for awasef kon turn from God as wi dey make ofrin and sakrifice on-top am or dey offa ofrin of peace for awasef, make God ensef ponish us.
JOS 22:24 “Wi swear sey wetin make us do like dis na, bikos wi dey fear sey tumoro una shidren-shidren fit dey ask awa shidren-shidren sey, ‘Who give una di rite to woship di Oga wey bi Israel God?
JOS 22:25 Na God make Jordan River as boundary between wi and una (Reuben and Gad tribe). So una nor get rite to woship God.’ And if e happen like dat, una shidren-shidren fit make awa own stop to woship and obey God.
JOS 22:26 “So wi kon agri sey make wi build dis altar, nor bi to burn ofrin or to sakrifice put,
JOS 22:27 but na to remind us and una and awa shidren-shidren sey, wi go woship God for en present with burn ofrin, sakrifice and peace ofrin. Den, tumoro una shidren-shidren nor go fit tell awa own sey, ‘Una nor get rite to woship God.’
JOS 22:28 “Wi kon sey, ‘If dem tell us or awa shidren-shidren dis kind tin tumoro, wi go ansa dem sey, “Si di fine altar wey awa grand-grand papa build for God, nor bi for burn ofrin or sakrifice, but na to dey remind wi and una.” ’
JOS 22:29 “Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”
JOS 22:30 Wen Finehas wey bi priest, di kommunity and di family leaders wey kom with am hear wetin Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe tok, body kon sweet dem well-well.
JOS 22:31 Finehas wey bi Eleazar pikin and di priest kon tell Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe sey, “Today wi don know sey God dey among us, bikos una neva disobey God at-all. Naw, una don save all Israel pipol from God vexnashon.”
JOS 22:32 Finehas wey bi Eleazar pikin, di priest and di leaders kon leave Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe for Gilead town kon go ripot give di whole Israel wey dey Shiloh for Kanaan land.
JOS 22:33 Wen dem tell Israel pipol evritin, belle sweet dem and dem kon tank God. Dem nor ever tok again sey dem go distroy Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.
JOS 22:34 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon name di altar and sey, “Really e go dey remind us sey na di Oga bi God.”
JOS 23:1 E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.
JOS 23:2 So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well.
JOS 23:3 Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.
JOS 23:4 Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.
JOS 23:5 Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.
JOS 23:6 “Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite,
JOS 23:7 or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem!
JOS 23:8 But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.
JOS 23:9 “For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today.
JOS 23:10 Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.
JOS 23:11 Make una dey very kareful! Make una love di Oga wey bi una God!
JOS 23:12 “If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some,
JOS 23:13 den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.
JOS 23:14 “Make una listin, I go soon die. Una know with all una heart and body sey evritin wey God promise sey E go do, E don do am for us!
JOS 23:15 And na so, E don do evritin wey E promise una sey E go do for una, but if una disobey, God go bring all di judgement for una head, until E distroy una from dis good land wey di Oga una God give una.
JOS 23:16 If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.”
JOS 24:1 Joshua gada Israel pipol for Shekem. E koll Israel leaders, rulers, judge and all of dem kom God present.
JOS 24:2 Joshua tell di pipol, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok: ‘Before-before, una grand-grand papa dey stay afta Eufrates River, plus Terah wey bi Abraham and Nahor papa. Dem woship anoda god,
JOS 24:3 but I take una papa Abraham cross di river kon bring am kom Kanaan land. I make en shidren-shidren many and dem nor fit kount dem; I gi-am Isaak
JOS 24:4 and Isaak born Jakob and Esau. I give Esau, Mount Seir, while Jakob and en boys shidren go Egypt.
JOS 24:5 “ ‘I send Moses and Aaron go Egypt kon skata Egypt rish groun wen I enter di land. Den I bring una kom out from Egypt.
JOS 24:6 Afta, I take una papa dem kom out from Egypt and wen dem waka rish di Red Sea, Egypt soja porshu dem with shariot.
JOS 24:7 Una papa kry to God make E help dem; den di aria between una papa and Egypt sojas, God make am dark kon kill all Egypt sojas inside di sea. Wetin E do for Egypt, una si am with una own eye. Una stay tey for di desert.
JOS 24:8 “ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.
JOS 24:9 King Balak wey Zippor born for Moab kon attack Israel. E koll Balaam, Beor son sey make e curse una.
JOS 24:10 I nor gri listin to Balaam; instead e dey tok good tins about una and I save una from en pawa.
JOS 24:11 “ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem.
JOS 24:12 I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow.
JOS 24:13 I give una land wey una nor work hard to get; una dey big-big towns where una nor build house put and una dey chop fruits wey dem produce for vineyard and olive wey una nor plant.’
JOS 24:14 “Naw, make una obey God kon dey loyal as una dey woship am with betta mind. Make una forget di gods wey una grand-grand papa dey serve before-before for di oda side for di river and for Egypt and make una kom woship God.
JOS 24:15 If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”
JOS 24:16 Di pipol ansa, “Make God ponish us, if wi go woship anoda god!
JOS 24:17 Bikos na di Oga awa God take wi and awa papa dem komot from sofa for Egypt kon do all doz mirakles for awa front. E still protet us wen wi dey travel pass difren kountries.
JOS 24:18 God porshu all doz nashons komot for us, plus Amor pipol wey dey stay di land. So wi go woship di Oga God, bikos na-im bi awa God!”
JOS 24:19 Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.
JOS 24:20 If una forget God kon go woship anoda god, E go turn against una; E go bring wahala kom meet and distroy una, even doh E trit una as pikin before.”
JOS 24:21 Di pipol ansa Joshua, “Lie-lie! Na God wi go serve till wi die!”
JOS 24:22 Joshua tell di pipol, “Na una bi una own witness sey una dey sey, ‘Una go serve God till una die.’ ” Di pipol ansa, “Yes! Na wi bi awa own witness.”
JOS 24:23 Den Joshua sey, “So make una trowey all di oda gods wey una get kon respet only di Oga wey bi Israel pipol God.”
JOS 24:24 Di pipol tell Joshua, “Wi go woship di Oga awa God and wi go obey am.”
JOS 24:25 Dat day, Joshua agri with di pipol kon give dem kommand and as dem go take follow am for Shekem.
JOS 24:26 Joshua rite dis words for God book. E arrange big-big stones kon put di book on-top dem, under di oak tree near God Temple.
JOS 24:27 Joshua tell di pipol, “Si, dis stones go bi witness against una, bikos e don hear evritin wey God tell una. E go bi witness against anybody wey deny awa God.”
JOS 24:28 Den Joshua sey make evribody dey go and di pipol kon go back to di land wey dem divide give dem.
JOS 24:29 Afta all dis tins don happen, Joshua wey bi Nun pikin and God savant kon die wen e bi one hundred and ten years.
JOS 24:30 Dem beri am for di land wey dem gi-am for Timnat-Serah for Mount Gaash nort wey dey Efraim hill kountry.
JOS 24:31 Thru-out di time wey Joshua dey alive with doz leaders wey dey with am (before all of dem die), Israel pipol woship God. Dis leaders don si evritin wey God do for Israel pipol.
JOS 24:32 Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.
JOS 24:33 Eleazar wey bi Aaron pikin kon die too and dem beri am for Gibeah for di hill kountry for Efraim, where en pikin Finehas for get land.
JDG 1:1 Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”
JDG 1:2 God ansa, “Na Judah tribe, bikos I don give dem viktory ova di land.”
JDG 1:3 Den Judah men tell dia relashon from Simeon tribe sey, “Make una join us go fight Kanaan pipol wey dey di aria wey God give us. Den wi go follow una go fight and win una own aria too.” So Simeon men follow Judah pipol.
JDG 1:4 Wen Judah men attack, God make dem win Kanaan and Periz pipol and dem kill 10,000 men wey dey fight war for Bezek town.
JDG 1:5 As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol.
JDG 1:6 King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.
JDG 1:7 So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.
JDG 1:8 Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.
JDG 1:9 Afta, dem go fight Kanaan pipol wey dey stay for di hill kountry; Negev and for di hill bottom wey dey for di west side.
JDG 1:10 Dem mash against Kanaan pipol for Hebron (wey dem dey koll Kiriat-Arba before), dem stay der kon fight and win Sheshai, Ahiman and Talmai pipol.
JDG 1:11 From der, dem go fight doz wey dey Debir town (wey dem dey koll Kiriat-Sefer before).
JDG 1:12 Den Kaleb sey, “I go give my dota Aksah as wife to anybody wey go attack and seize Kiriat-Sefer.”
JDG 1:13 Kenaz wey bi Kaleb yonga broda, na-im pikin Otniel attack and seize Kiriat-Sefer. So Kaleb pikin, Aksah kon bi Otniel wife.
JDG 1:14 Di day wen Otniel dey marry Aksah, e kon tell di girl sey make e ask en papa for land. So as di girl kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont?”
JDG 1:15 E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.
JDG 1:16 Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
JDG 1:17 Afta, Judah pipol join Simeon pipol go fight Kanaan pipol for Zefat and dem skata di town finish. Leta, dem kon koll di town, Hormah.
JDG 1:18 Dem still attack Gaza, Ashkelon and Ekron town and di oda towns wey dey near der.
JDG 1:19 God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.
JDG 1:20 So dem give Kaleb, Hebron town just as Moses promise. So Kaleb porshu Anak generashon komot der.
JDG 1:21 Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
JDG 1:22 Josef shidren-shidren, attack Bethel town and God help dem.
JDG 1:23 Dem send men go spy Bethel (wey dem dey koll Luz before).
JDG 1:24 Dem meet one man dey kom out from di town kon ask am, “Make yu show us how to enter dis town and wi nor go kill yu.”
JDG 1:25 So e show dem and dem kill evribody wey dey di town, escept di man and en family.
JDG 1:26 Leta, di man komot from der kon go Hit pipol land and e build en own town wey e koll, Luz for der. Naim dem still dey koll am till today.
JDG 1:27 Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der.
JDG 1:28 Israel pipol kon get pawa well-well and dem force and turn Kanaan pipol to dia slave, but dem nor drive all of dem komot from di land.
JDG 1:29 Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem.
JDG 1:30 Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave.
JDG 1:31 Asher tribe nor fit drive di pipol wey dey Akko, Sidon, Ahlab, Akzib, Helbah, Afek and Rehob, komot.
JDG 1:32 Instead, Asher pipol dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land, bikos dem nor fit porshu dem komot.
JDG 1:33 Na so too, Naftali tribe nor fit drive Bet-Shemesh and Bet-Anat pipol komot, instead, dem dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land. Dem force di pipol to work for dem as dia slave.
JDG 1:34 Amor pipol force Dan tribe go stay for di kountries wey dey di hill and dem nor let dem kom down again.
JDG 1:35 Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave.
JDG 1:36 Amor pipol borda start from Skorpion Pass go rish Sela and e still kontinue from der go.
JDG 2:1 God angel komot from Gilgal go Bokim kon tell Israel pipol, “Na mi bring una kom out from Egypt kon put una for dis land wey I promise to give una grand-grand papa and I tok sey I nor go break my promise with una.
JDG 2:2 I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’
JDG 2:3 For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”
JDG 2:4 Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry.
JDG 2:5 So dem koll di place Bokim (wey mean “Cry”) kon offa sakrifice give God.
JDG 2:6 Afta Joshua don sey make di pipol dey go, each tribe komot go take di land wey dem divide for dem.
JDG 2:7 So thru-out Joshua time, Israel pipol serve God and even afta e don die, dem still kontinue to dey serve am, since di leaders wey si all di good-good tins wey God do for dem still dey alive.
JDG 2:8 Joshua wey bi Nun pikin, God savant, die wen e bi one hundred and ten years.
JDG 2:9 Dem beri am for en land wey dey Timnat-Heres, for Efraim hill kountry, near di nort side for Mount Gaash.
JDG 2:10 Afta dat generashon die finish, di next generashon forget God and evritin wey E don do for dem.
JDG 2:11 Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.
JDG 2:12 Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.
JDG 2:13 Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.
JDG 2:14 Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.
JDG 2:15 Anytime wen Israel pipol go fight war, God dey-dey against dem, just as God tok before and dem sofa well-well.
JDG 2:16 Den God give Israel pipol leaders wey kom save dem from dia enemies hand.
JDG 2:17 But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.
JDG 2:18 As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.
JDG 2:19 But anytime di leaders die, dem go-go kontinue di bad-bad tins wey dem dey do. Dia own kon even worse pass di ones wey dia grand-grand papa do. Dem follow oda gods; dey serve and woship dem; dem nor gri stop dia sturbones and dem still dey do bad-bad tins.
JDG 2:20 So, God vex well-well for dem kon sey, “Bikos dis pipol don break my kovenant wey I make with dia grand-grand papa and forget my kommand,
JDG 2:21 I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.
JDG 2:22 I go use am take test dem weda dem go follow mi, just as dia grand-grand papa do.”
JDG 2:23 Na dis make God leave di nashons for der. E nor drive dem komot or allow Joshua win all of dem.
JDG 3:1 Dis na di nashons wey God leave for di land to take test Israel pipol wey neva fight war with Kanaan pipol before.
JDG 3:2 E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before.
JDG 3:3 Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.
JDG 3:4 God leave dis pipol to take test Israel pipol, weda dem go obey di kommand wey E give dem thru Moses, dia grand-grand papa.
JDG 3:5 So Israel pipol kon dey stay among Kanaan, Hit, Amor, Perez, Hiv and Jebus pipol
JDG 3:6 and dem marry demsef too. Israel sons marry Kanaan girls; while Israel girls marry Kanaan sons and Israel pipol kon dey serve Kanaan gods.
JDG 3:7 Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju.
JDG 3:8 So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.
JDG 3:9 Wen Israel pipol kry give God make E help dem, God kon send one man among dem wey save dem. En name na Otniel wey en papa na Kenaz wey bi Kaleb yonga broda.
JDG 3:10 God Spirit enter am, so e kon bi leader for Israel. E go war go fight against King Kushan-Rishataim and God kon help Otniel, win am.
JDG 3:11 So peace kon dey di land for forty years. Den Otniel wey bi Kenaz pikin kon die.
JDG 3:12 Israel pipol sin against God again, so God kon give dem to King Eglon for Moab.
JDG 3:13 King Eglon join Ammon and Amalek pipol kon fight and win Israel pipol, den dem take Jeriko town wey palm tree full.
JDG 3:14 Israel pipol serve King Eglon for Moab, for eighteen years.
JDG 3:15 But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift.
JDG 3:16 Ehud make swod wey get two mout and e long small. E hide am for di rite side under en klot.
JDG 3:17 Den e take gift go give King Eglon wey fat well-well.
JDG 3:18 Wen Ehud don gi-am di gift, en and di men wey bring di gift kon dey go house back.
JDG 3:19 But Ehud go back go meet King Eglon and wen e rish di Idol Stone near Gilgal, e kon tell am, “My oga, I get one sekret message for yu.” So di king kommand en savants, “Make una kwayet!” Den e sey make dem komot from di room.
JDG 3:20 So Ehud waka go meet Eglon for where e sidan alone for one kool room for upstair, den e sey, “I get one message from God for yu!” As King Eglon get up from en chair,
JDG 3:21 Ehud use en left hand bring out di swod for where e hide am put kon shuk di king for belle.
JDG 3:22 Di swod enter di King belle well-well sotey e kover di swod head. So Ehud nor fit pul di swod komot from en belle and all di king intestine kon kom out.
JDG 3:23 Den Ehud go outside, klose and lock di door, den e kon pass di toilet run go.
JDG 3:24 Afta Ehud don go, di king savant kon si sey di room door dey lock. Dem tink sey di king dey di toilet for di palor,
JDG 3:25 so dem kon dey wait, but afta sometaim wen e nor kom out, dem take di key open di door kon si dia masta don die for groun.
JDG 3:26 Ehud run pass di Idol Stone go Seirah, as di oda savants still dey wait.
JDG 3:27 Wen e rish di hill kountry for Efraim, e blow trumpet kon koll Israel men for war; den e lead dem kom down from di hill.
JDG 3:28 E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross.
JDG 3:29 Dat day, dem kill about 10,000 men wey strong well-well for Moab and no one among dem fit eskape.
JDG 3:30 So Israel pipol win Moab pipol dat day and peace kon dey di land for eight years.
JDG 3:31 Afta Ehud, di next leader wey Israel get na, Shamgar, Anat pikin and en too save Israel pipol wen e use animal bone take kill 600 Filistia pipol.
JDG 4:1 Afta Ehud die, Israel pipol sin against God again.
JDG 4:2 So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.
JDG 4:3 Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.
JDG 4:4 Dat time, Deborah wey bi Lappidot wife, na profetes and judge for Israel.
JDG 4:5 E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem.
JDG 4:6 One day, e send message go koll Barak, Abinoam pikin, wey dey stay for Kedesh for Naftali land kon tell am, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God kommand sey make yu do: Make yu koll 10,000 wariors from Naftali and Zebulun tribe go Mount Tabor.
JDG 4:7 And I go bring Sisera, kommander for Jabin sojas, with en war horse and warrior kom Kishon River and for der, I go give una viktory ova am.”
JDG 4:8 But Barak ansa, “If yu nor follow mi go, I nor go-go anywhere.”
JDG 4:9 Den Deborah sey, “Okay! I go follow yu go, but nobody go praiz yu for dis war, bikos God don sey na woman go kill Sisera.” So Deborah kon follow Barak go Kedesh.
JDG 4:10 Barak koll Zebulun and Naftali tribe kon gada dem togeda for Kedesh and na 10,000 wariors follow am. Deborah still follow am go too.
JDG 4:11 By dis time, Heba, one Kenite man, komot from where en oda tribe pipol dey, go build en tent for near Kedesh, near one oak tree for Zaanannim. Na Moses broda-in-law wey Hobab bi en grand-grand papa.
JDG 4:12 Wen dem tell Sisera sey, Barak, Abinoam pikin don go Mount Tabor,
JDG 4:13 e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.
JDG 4:14 Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men.
JDG 4:15 Wen Barak attack, God kon konfuse Sisera and en men. Sisera kom down from en war horse kon take leg dey run.
JDG 4:16 But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.
JDG 4:17 By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.
JDG 4:18 Jael go outside go meet Sisera kon tell am, “My oga! Make yu kom inside my house. Make yu nor fear at-all.” So Sisera go inside, den di woman hide am kon take blanket kover am.
JDG 4:19 Sisera tell am, “Abeg, make yu give mi wota drink, bikos my trot don dry.” So di woman gi-am milk from one leda bag, den kon kover am again.
JDG 4:20 Den Sisera tell di woman, “Make yu stand for di door and if anybody kom ask yu weda pesin dey here, make yu sey no.”
JDG 4:21 But as Sisera dey sleep, bikos e don taya well-well, Jael kon take hammer and nail waka small-small go near am kon nail en head from di korna join groun, so Sisera kon die.
JDG 4:22 Wen Barak find Sisera rish der, Jael tell am, “Make yu kom si di man wey yu dey find.” So Barak follow di woman enter di tent and e kon si sey Sisera don die, bikos di woman nail en head join groun.
JDG 4:23 So for dat day, God kon give Israel pipol viktory ova Jabin wey bi Kanaan pipol king.
JDG 4:24 From dat time go, Israel pipol kon get pawa and strong more-more pass King Jabin, until dem distroy am finish.
JDG 5:1 For dat day, Deborah and Barak, Abinoam pikin, sing dis song:
JDG 5:2 “Make una praiz God! Israel leaders agri to go fight and di pipol happy follow dem.
JDG 5:3 Una wey bi king, make una listin! Una wey bi rulers, make una hear mi! Bikos I go sing and play music give God, di Oga for Israel.
JDG 5:4 My God, wen Yu komot from Seir go Edom, di eart shake and rain start to fall from di sky;
JDG 5:5 di Oga wey bi Sinai and Israel God, mountins skata for yor present.
JDG 5:6 For di time wey Shamgar, Anat pikin and Jael dey rule, pipol nor dey gri pass di main road and dem dey hide travel.
JDG 5:7 Na only few pipol remain for Israel village, until Deborah kom stand as Israel pipol mama.
JDG 5:8 Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?
JDG 5:9 I like doz leaders for Israel and doz wey gri to fight war. Make wi praiz God!
JDG 5:10 Una wey dey ride fine donkey; wey dey use fine blanket for una horse and doz wey dey take leg waka, make una tok about am.
JDG 5:11 Make una listin, doz wey dey near di well dey sing, bikos God and Israel pipol don win! Den God pipol go mash kom from dia towns.
JDG 5:12 Deborah, make yu wake-up! Deborah, I sey make yu wake-up! Make yu wake-up kon sing song! Barak wey bi Abinoam pikin, make yu stand up go free doz wey dey prison.
JDG 5:13 Den doz wey remain kom down from Tabor go meet dia leaders. God pipol dey ready to fight.
JDG 5:14 Dem from Efraim go di valley, di land wey bi Amalek pipol own before and dem follow Benjamin tribe with en men. Di kommanders kom from Makir and di ofisas kom from Zebulun.
JDG 5:15 Di prince dem for Issakar dey with Deborah and Barak. Dem follow Barak go di valley. But Reuben tribe divide, bikos dem nor gri kom.
JDG 5:16 Why una sidan for house with di sheep? Na to listin to di shepad wen dem koll dia animals? ‘Yes!’ Reuben tribe divide and dem nor gri kom.
JDG 5:17 Gilead pipol dey for Jordan River east, while Dan pipol dey near di sheep. Asher pipol nor gri komot from di wotaside, dem dey stay near di river.
JDG 5:18 But Zebulun and Naftali pipol risk dia life kon go fight war.
JDG 5:19 Kanaan kings kom fight for Taanak near Megiddo wota, but dem nor take any silva komot der.
JDG 5:20 From di sky, di stars dey move and fight against Sisera.
JDG 5:21 Kishon River karry dem go. So I go mash face dem with full force!
JDG 5:22 Di horse dem dey shake di groun, bikos dem dey mash am pass with force.
JDG 5:23 God angel sey, ‘Make una curse Meroz pipol. Make curse follow dem, bikos dem nor gri help God pipol; dem nor kom fight for dem.’
JDG 5:24 Jael wey en husband na Heba wey kom from Kanaan, na-im dey bless pass among evry woman. Na Jael God bless pass all di wimen wey dey stay tent.
JDG 5:25 Sisera ask am for wota, but e gi-am milk. E use fine bowl take bring di milk for am.
JDG 5:26 Den e use en left hand take hold di nail kon hammer Sisera thru en head with en rite hand.
JDG 5:27 Sisera fall kon knee down for di woman front. Na di woman leg e fall near and na der e for die
JDG 5:28 Sisera mama look outside from window, bikos e dey wait for Sisera make e kom, den e kon sey, ‘Why en shariot nor kwik kom? Why wi nor dey hear en shariot nois?’
JDG 5:29 Di wise wimen dem ansa am, but di woman still dey tell ensef sey,
JDG 5:30 ‘May bi dem dey divide di tins wey dem seize; dat is, one girl or two for evry man. Sisera dey gada fine klot; klot wey dem design well. Yes! Fine-fine robe wey dem design for di two side, dey join wetin dem seize.’
JDG 5:31 My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.
JDG 6:1 Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years.
JDG 6:2 Midian pipol get pawa well-well and Israel pipol kon dey hide for rock and oda place wey dey save for di hills.
JDG 6:3 Anytime wen Israel pipol plant, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert go kon attack dem.
JDG 6:4 Dem go kamp for di land kon distroy all dia plants from di aria for sout go rish Gaza. Dem go karry all di animals and dem nor go leave anytin make Israel pipol chop.
JDG 6:5 Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land
JDG 6:6 and Israel pipol nor fit do dem anytin.
JDG 6:7 Den, Israel pipol kon kry give God make E help dem.
JDG 6:8 So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave.
JDG 6:9 I save una from Egypt pipol and from all di pipol wey opress una. I porshu all una enemies kon give una dia land.
JDG 6:10 Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”
JDG 6:11 Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am.
JDG 6:12 Di angel appear to am kon sey, “Strong man, God dey with yu!”
JDG 6:13 Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”
JDG 6:14 Den God angel turn kon tell am, “Make yu go with di pawa wey yu get kon save Israel pipol from Midian pipol, bikos na mi dey send yu!”
JDG 6:15 Gideon ansa, “My Oga! Na how I go take save Israel pipol? Na my family weak pass for Manasseh tribe and na mi small pass for di family!”
JDG 6:16 Den di angel tell am, “Yu go fit do am, bikos I go dey with yu and yu go distroy Midian pipol like sey yu dey fight one pesin.”
JDG 6:17 Gideon sey, “If yu go really help mi, den make yu show mi sign, so dat I go know sey na di Oga God really dey tok to mi.
JDG 6:18 Abeg, make yu nor komot until I bring food kon offa give yu.” Di angel ansa, “I go stay here until yu kom.”
JDG 6:19 Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.
JDG 6:20 Di angel tell am, “Make yu put di meat and di bread for dis rock, den pour di oil on-top.” So Gideon do as e tok.
JDG 6:21 God angel tosh di meat and bread with di stik wey e hold and fire kom out from di rock kon burn di food finish. Den di angel disappear.
JDG 6:22 Gideon bigin kry, wen e kon know sey na God angel bi dat, den e sey, “My Oga God wey get pawa, I don si yor angel face-to-face!”
JDG 6:23 But God tell am, “Nor worry or fear, bikos yu nor go die.”
JDG 6:24 So Gideon build one altar for der give God kon koll am, “Yahweh Shalom wey mean, ‘Na Oga God bi peace.’ ” Till today, di altar still dey for Ofrah wey bi Abiezer family land.
JDG 6:25 Dat nite, God tell Gideon, “Make yu take yor papa melu and anoda seven years melu, den distroy and skata yor papa Baal altar and di Asherah juju wey dey near am.
JDG 6:26 Den, yu go build betta altar for di Oga yor God on-top dis hill. Afta yu don build di altar, yu go take di sekond melu kon burn am as ofrin for di altar and yu go use di Asherah juju pole wey yu skata, take do firewood.”
JDG 6:27 So Gideon take ten among en savant follow body go do wetin God tok. But e do am for nite, bikos e dey fear en family and di pipol for di town.
JDG 6:28 Wen di pipol wake-up di next day, dem si sey dem don distroy di juju altar kon skata di Asherah juju wey dey near am. Dem kon si di sekond melu wey dem burn as ofrin on-top di new altar wey dem build for der.
JDG 6:29 So dem ask demsef, “Na who do dis tin?” Afta dem don ask evribody, dem kon know sey na Gideon wey bi Joash pikin, do am.
JDG 6:30 So di pipol tell Joash, “Make yu bring yor pikin kom out, bikos e must die for wetin e do so.”
JDG 6:31 But Joash tell di pipol wey kom meet am, “Why una dey fight for di juju? Una dey defend am? Anybody wey won fight or defend di juju, dem go kill-am before morning! If Baal really bi god, den make e defend ensef kon distroy and kill di pesin wey skata en altar!”
JDG 6:32 From dat time go, dem kon dey koll Gideon, “Jerub-Baal,” bikos Joash sey, “Make Baal defend ensef, bikos na en altar dem distroy.”
JDG 6:33 Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley.
JDG 6:34 Na wons God Spirit enter Gideon body, so e blow trumpet take koll all Abiezer family kom out make dem follow am.
JDG 6:35 E send messenjas go Manasseh, Asher, Zebulun and Naftali sey make all dia sojas kom and dem kon follow am.
JDG 6:36 Den Gideon tell God, “If Yu won really use mi take save Israel, just as Yu promise,
JDG 6:37 den make Yu show mi with di sign wey I go ask for: Dis nite, I go put wool for where wi for dey pick wheat, but wen day break and I si sey dew wet di wool and di groun dey dry, den I go know sey Yu go help mi save Israel pipol, just as Yu promise.”
JDG 6:38 And evritin happen as Gideon tok am. Wen Gideon wake-up for morning, e skwiz di wool and di wota wey kom out, full one bowl.
JDG 6:39 Den Gideon tell God, “Abeg! Make Yu nor vex for mi sey I still won tok, bikos I still like do one test with di wool and dis time, I like make di wool dey dry, while di groun go soak with wota.”
JDG 6:40 So dat nite, God do wetin Gideon ask for. Di next day, di wool dry well-well, but dew soak di groun.
JDG 7:1 One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill.
JDG 7:2 God kon tell Gideon, “Di men wey yu get too many for mi to give una viktory ova Midian pipol. Dem go tink sey na dem win by demsef and bikos of dat, dem nor go kon tank mi.
JDG 7:3 So make yu tell dem, ‘Anybody wey dey fear, make e go back to en house and wi go stay here for Mount Gilead.’ ” So 22,000 pipol kon go house back, but 10,000 pipol still remain.
JDG 7:4 But God still tell Gideon, “Di men wey yu get still too many, make yu take dem go di wota and I go choose di ones wey I wont, for der. If I tell yu sey, ‘Make dis man follow yu,’ e go follow and if I sey, ‘Make dis man nor follow,’ e nor go follow yu.”
JDG 7:5 So Gideon take di men go di wota, den God tell am, “Make yu take doz wey drink di wota like dog and nor bi doz wey go knee down drink am.”
JDG 7:6 And na only three hundred men drink di wota like dog, but di rest knee down drink am.
JDG 7:7 God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.”
JDG 7:8 So Gideon send di men go dia house, escept di three hundred men wey follow di rules and na dem dey keep di trumpets. Midian pipol kamp dey under Israel pipol own for di valley.
JDG 7:9 Dat nite, God tell Gideon, “Get up make yu go attack Midian pipol, bikos I don give yu viktory.
JDG 7:10 But if yu dey fear to attack, make yu and yor savant Purah, go di kamp
JDG 7:11 and una go hear wetin dem dey tok, den from der, yu go get di mind to attack.” So Gideon and en savant Purah kon go near dia enemy kamp.
JDG 7:12 Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.
JDG 7:13 Wen Gideon rish der, e hear one man dey tell en friend about di dream wey e dream kon sey, “I dream sey, bread wey nor get yist roll enter awa kamp kon nak and skata awa tents for groun.”
JDG 7:14 So di friend ansa, “True-true, Gideon, Joash pikin wey kom from Israel, na en swod bi dat o-o! Na wetin di dream mean bi dat! God don gi-am viktory ova Midian pipol and all awa sojas.”
JDG 7:15 Wen Gideon hear di dream and wetin e mean, e knee down kon woship God. Den e go back to en kamp kon sey, “Make una get up! Bikos God don give us viktory ova Midian sojas.”
JDG 7:16 E divide en three hundred men into three groups kon give each pesin trumpet and cup wey tosh dey inside.
JDG 7:17 E tell dem, “Wen wi rish di kamp korna, make una do anytin wey I do.
JDG 7:18 And as mi and my group blow awa trumpet, make una blow una own round di kamp kon shaut, ‘Dis one na for God and for Gideon!’ ”
JDG 7:19 As dem just shange doz wey dey guide before mid-nite, Gideon and en hundred men kom di kamp korna kon blow dia trumpet and break di cup wey dey dia hand,
JDG 7:20 den di oda group, do di same tin too. All of dem hold dia tosh for dia left hand, while di trumpet dey dia rite hand and dem kon shaut, “One swod for God and for Gideon!”
JDG 7:21 Each man stand for one place round di kamp and dia enemies sojas kon dey shaut run komot from di place wey dem dey.
JDG 7:22 Wen Gideon men dey blow dia trumpet, God make di enemies bigin fight demsef with dia swod. So dem run go Zaretan, wey far rish Bet-Shittah and Abel-Meholah town, near Tabbat.
JDG 7:23 Israel pipol from Naftali Asher and Manasseh tribes kom out kon porshu Midian pipol.
JDG 7:24 Gideon send messenjas go all di hill kountry for Efraim sey, “Make una kom join mi fight Midian pipol and make una guide Jordan River and di small rivers go rish Bet-Barah, so dat Midian pipol nor go cross go der.” So Efraim men kon go guide di river.
JDG 7:25 Dem katch two Midian shief wey bi, Oreb and Zeeb. Dem kill Oreb for Oreb rock and Zeeb for where dem for dey press wine and di place name na Zeeb. Israel pipol still porshu Midian pipol, but dem bring Oreb and Zeeb head kom give Gideon for Jordan River east.
JDG 8:1 Den Efraim men tell Gideon, “Why yu do us like dis? Wen yu dey go fight Midian pipol, why yu nor koll us?” Dem kon dey komplain about am.
JDG 8:2 But e tell dem, “Make una nor vex! Even doh una nor kwik kom, wetin una do still big pass di ones wey mi and my men do. E just bi like wen dem harvest grape: di grape wey Efraim tribe waka leave for groun, betta pass all di ones wey Abiezer harvest!
JDG 8:3 Si, na una use God pawa take kill Midian pipol two shief, wey bi Oreb and Zeeb. Wetin I do wey rish dat one?” Wen e tok like dis finish, di pipol kon stop to vex.
JDG 8:4 For dis time, Gideon and en three hundred men don cross Jordan River. Dem don taya, but dem still dey porshu dia enemies.
JDG 8:5 Wen dem rish Sukkot, Gideon tell di men for di town sey, “Abeg, make una give my men some bread make dem chop, dem don taya and I dey porshu Zebah and Zalmunna wey bi Midian pipol kings.”
JDG 8:6 But Sukkot leaders ansa, “Why yu wont make wi give yor men food wen una neva katch Zebah and Zalmunna.”
JDG 8:7 So Gideon ansa, “Okay no problem! By di time wey God go put dem for my hand, I go flog una with kane and shuku-shuku wey I plok from desert!”
JDG 8:8 So Gideon go Penuel go meet di pipol wey dey der kon beg dem for di same tin, but dem ansa am, just like Sukkot leaders.
JDG 8:9 E tell dem, make una nor worry, “I dey go, I go kom back alive and nor-tin go do mi. And by di time wey I kom back, I go distroy una towa!”
JDG 8:10 By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.
JDG 8:11 Gideon pass di road wey dey di desert korna for di east side for Nobah and Jogbehah kon go attack di sojas for der.
JDG 8:12 Di two Midian king wey bi Zebah and Zalmunna run komot, but e porshu and katch dem and dis tin kon make all di sojas sopraiz.
JDG 8:13 Wen Gideon dey kom back from di war, e kon pass thru Heres Pass and
JDG 8:14 e katch one man from Sukkot kon ask am kweshon, den di man rite di 77 leaders name for Sukkot, give Gideon.
JDG 8:15 Den Gideon go meet Sukkot men kon tell dem, “Una remember di time wen una sey una nor go fit help mi? Una sey una nor go fit give my sojas wey don taya food to chop, bikos I neva katch Zebah and Zalmunna. Naw, make una si dem!”
JDG 8:16 So e take kane and shuku-shuku from di desert kon flog Sukkot leaders.
JDG 8:17 E still distroy Penuel towa kon kill di men wey dey di town.
JDG 8:18 Den, Gideon ask Zebah and Zalmunna, “Di men wey una kill for Tabor, make una tell mi how dem bi!” Dem ansa, “Dem bi like yu, all of dem bi like king pikin.”
JDG 8:19 So Gideon sey, “Dem bi my brodas, my mama shidren. If to sey una nor kill dem, I swear I nor for kill una.”
JDG 8:20 Den e tell en senior pikin Jeta, “I kommand yu make yu kill dem!” But di pikin nor gri bring out en swod, e dey fear, bikos e still bi small boy.
JDG 8:21 So Zebah and Zalmunna kon tell Gideon, “Make yu kill us yorsef, bikos yu nid to get heart like man first, before yu go fit do wetin man dey do.” So Gideon kill dem kon take di gold wey dey dia kamel neck.
JDG 8:22 Leta, Israel pipol tell Gideon, “Make yu bi awa ruler, yu and yor shidren-shidren, bikos yu don save us from Midian pipol hand.”
JDG 8:23 But Gideon ansa, “I nor go fit bi una ruler, even my pikin nor fit. Na God go bi una ruler.”
JDG 8:24 And e still sey, “Make I beg una for one tin. Make all of una give mi di ear-ring wey una take from Midian pipol.” (dis na bikos, Midian pipol and oda desert pipol, dey wear gold ear-ring.)
JDG 8:25 Di pipol ansa, “Wi go dey happy to give yu.” So dem put klot for groun and evribody kon put di ear-ring wey dem take.
JDG 8:26 Di gold ear-ring wey Gideon kollect, heavy rish 20 kilogram and dis ones nor join di fine-fine gold, necklaces and di purpol klot wey Midian king dem dey wear and di kollar wey dey round dia kamel neck.
JDG 8:27 So Gideon make image with di gold kon put am for Ofrah wey bi en own town. Israel pipol forget God kon go der dey go woship di image. And e kon turn wahala for Gideon and en family.
JDG 8:28 So Israel pipol win Midian pipol and dem nor kon dey fear dem again. Di land kon get peace for forty years until Gideon die.
JDG 8:29 Gideon go back to en own town kon stay der.
JDG 8:30 E get 70 sons, bikos e marry many wife.
JDG 8:31 E still get one girl-friend for Shekem wey born one pikin for am and e kon koll am, Abimelek.
JDG 8:32 Gideon, Joash pikin, old well-well before e die and dem beri am for en papa Joash grave, for Ofrah wey dey Abiezer town.
JDG 8:33 Afta Gideon don die, Israel pipol kon dey sin against God, bikos dem dey woship Baal.
JDG 8:34 So dem nor kon dey serve and woship di Oga God wey save dem from all dia enemies wey dey around dem.
JDG 8:35 Even with all di good tins wey Gideon do for Israel pipol, dem still dey trit en family anyhow.
JDG 9:1 Naw, Abimelek wey bi Gideon pikin, go Shekem town, where all en mama family dey stay kon tell dem
JDG 9:2 make dem ask Shekem men sey, “Wetin make una wont make Gideon 70 shidren rule una, wen e bi sey only one man fit rule una? Make una remember sey, Abimelek na una own flesh and blood o-o.”
JDG 9:3 So en mama family kon tok to di men and dem kon agri to follow Abimelek, bikos e bi dia own family pesin.
JDG 9:4 Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.
JDG 9:5 Den e go en papa house for Ofrah kon kill en step brodas, di 70 son wey Gideon born. E kill all of dem on-top one stone. But na only Jotam wey bi Gideon last born, run bikos e hide.
JDG 9:6 All di leaders for Shekem and Bet-Millo kon make Abimelek king for di oak tree near di pila for Shekem.
JDG 9:7 Wen Jotam hear wetin happen, e go stand on-top Mount Gerizim kon shaut tell di pipol wey dey groun sey, “Shekem leaders, make una hear mi, so dat God go hear una!
JDG 9:8 One day, all di tree gada togeda to choose king for demsef. Dem tell di olive tree sey, ‘Kom bi awa king!’
JDG 9:9 “But di olive tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my oil wey dem dey use take dey honor gods and human being, just bikos I won bi king!’
JDG 9:10 “Den all di tree tell di fig sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
JDG 9:11 “But di fig tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my good sweet fruit, just bikos I won bi una king.’
JDG 9:12 “So dem tell di grape vine sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
JDG 9:13 “But di grape vine ansa, ‘I nor go fit stop to produce my wine wey dey make gods and human being happy, just bikos I won bi una king.’
JDG 9:14 “Den all di tree kon tell shuku-shuku sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
JDG 9:15 “Di shuku-shuku ansa, ‘If una really wont make I bi una king, den make una kom stay under mi. If not, fire go from my shuku-shuku branches burn Lebanon cedars.’ ”
JDG 9:16 Naw Jotam kon sey, “Wen una make Abimelek una king, una really dey honest and sincere? Una respet Gideon kon trit en family well since e deserve am?
JDG 9:17 Make una remember sey, my papa fight and risk en life take save una from Midian pipol hand.
JDG 9:18 But today, una don turn una back against my papa family. Una kill en 70 son on-top one stone. Abimelek na en pikin wey di savant woman born for am and na una family, so una kon make am king for Shekem.
JDG 9:19 So, if wetin una do to Gideon and en family, dey good and honest, den make una happy with Abimelek and e go happy with una too.
JDG 9:20 But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”
JDG 9:21 Bikos Jotam dey fear Abimelek en broda, e kon run go stay for Beer.
JDG 9:22 Abimelek rule Israel pipol for three years.
JDG 9:23 Den God kon make Abimelek and Shekem men bigin fight demsef and dem kon go against am.
JDG 9:24 Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.
JDG 9:25 Shekem leaders hide some men for bush dey wait Abimelek and to rob anybody wey pass der. But Abimelek kon know about dia plan.
JDG 9:26 So wen Gaal, Ebed pikin kom Shekem with en brodas, di men for Shekem kon put dia hope on am.
JDG 9:27 All of dem go dia vineyard go pick grape kon make wine take do party. Dem go dia god temple dey drink, chop and curse Abimelek.
JDG 9:28 So Gaal sey, “Who bi dis Abimelek wey wi Shekem men dey serve? Nor bi Gideon pikin e bi? Zebul dey take orda from am, but why wi go serve am sef? Make una serve Hamor shidren, wey bi Shekem papa.
JDG 9:29 I wish sey, I dey lead dis pipol, I go kill Abimelek! I for tell am sey, ‘Make yu gada all yor soja kom out kon fight!’ ”
JDG 9:30 Wen Zebul wey dey rule di town, hear wetin Gaal tok, e kon dey vex.
JDG 9:31 E send messenjas go meet Abimelek for Arumah sey, “Gaal, Ebed pikin and en brodas kom Shekem and dem sey, dem nor go allow yu enter di town.
JDG 9:32 So naw, make yu and yor men kom out for nite kon hide for di town bush.
JDG 9:33 For morning, before sun kom out, make una attack di town, wen Gaal and en men kom out kon fight una, make una distroy dem finish!”
JDG 9:34 So Abimelek and en men kom out for nite; divide demsef kon hide for di bush outside Shekem.
JDG 9:35 Wen Abimelek and en men si sey, Gaal kom out kon stand for di town gate, dem stand up from where dem hide put.
JDG 9:36 Gaal si dem, so e kon tell Zebul sey, “Look! Some men dey kom down from di mountin!” Zebul ansa, “Nor bi human being dey kom! Na shadow yu dey si.”
JDG 9:37 But Gaal tell am again, “Look! Some men dey kom from di mountin centre and one group dey kom from di tree where pipol wey dey si vishon dey stay!”
JDG 9:38 Den Zebul tell am, “Nor bi yu sey, who bi Abimelek wey wi won serve? Dis nor bi di men wey yu curse? Go na! Make yu go fight dem!”
JDG 9:39 So Gaal lead Shekem men go fight Abimelek.
JDG 9:40 Gaal run and Abimelek kon porshu am. Many pipol wound go rish di town gate.
JDG 9:41 Abimelek go back to Arumah and Zebul kon drive Gaal and en brodas komot for Shekem.
JDG 9:42 For di next day, Shekem pipol kon go di field and wen Abimelek hear am,
JDG 9:43 e take en men, divide dem into three group kon hide for di bush around di field. Wen e si di pipol dey kom out from di town, en and en men kom out kon attack dem.
JDG 9:44 Abimelek and en group, attack kon block di road wey dem dey pass enter di town. Den di remainin two group kon attack and kill di pipol wey dey for di field.
JDG 9:45 Thru-out dat day, Abimelek fight for di town. E kill all di pipol for di town kon seize am. Den e skata di town kon pour salt full di groun.
JDG 9:46 Wen all di leaders for Shekem Towa hear wetin happen, dem kon run go hide for El-Berit temple.
JDG 9:47 Abimelek hear sey, all di leaders for Shekem Towa, gada for one place,
JDG 9:48 so en and en men go on-top Mount Zalmon. E take axe for en hand kon kut one branch from one tree. E put am for en shoulder kon tell en men, “Make una kwik-kwik do wetin una si mi dey do!”
JDG 9:49 So en men kut one-one branch kon follow am. Dem put di branches near di place where dem dey hide put kon lite fire der. All di pipol wey dey inside, die and dem bi like 1,000 men and wimen.
JDG 9:50 Den Abimelek go Tebez and e kom surround and seize am.
JDG 9:51 E get one strong towa for di town centre, so all di men, wimen and di leaders, run go der, lock di door kon go hide for di roof.
JDG 9:52 Wen Abimelek kom attack di towa, e go di door won kon lite fire put,
JDG 9:53 but one woman trow grindin stone from up kon land for en head and en brain kon krack.
JDG 9:54 E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die.
JDG 9:55 Wen Israel pipol si sey, Abimelek don die, dem kon go back to dia house.
JDG 9:56 God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas.
JDG 9:57 God still pay Shekem pipol back for di bad-bad tins wey dem do. And di curse wey Jotam, Jerub-Baal (wey bi Gideon) pikin curse dem, really follow dem.
JDG 10:1 Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol.
JDG 10:2 E lead Israel pipol for 23 years before e die and dem beri am for Shamir.
JDG 10:3 Afta am, Jair wey kom from Gilead kon lead Israel for 22 years.
JDG 10:4 E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village.
JDG 10:5 Jair die and dem beri am for Kamon.
JDG 10:6 Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
JDG 10:7 So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem.
JDG 10:8 Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years.
JDG 10:9 Ammon pipol cross Jordan River go fight Judah, Benjamin and Efraim tribe. And dis tin make Israel pipol weak well-well.
JDG 10:10 Den Israel pipol kon kry give God sey, “Wi don sin against Yu. Wi leave Yu kon dey woship Baal juju.”
JDG 10:11 So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia,
JDG 10:12 Sidon, Amalek and Maon pipol, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom save una from dia hand?
JDG 10:13 But una still leave mi kon dey woship oda gods, so I nor go save una again.
JDG 10:14 Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom save una wen una dey trobol.”
JDG 10:15 But Israel pipol tell God, “Wi don sin. So do us anytin wey Yu like, but today, wi dey beg sey make Yu kom save us.”
JDG 10:16 So dem skata all dia yeye gods kon bigin woship God; den God kon sorry for Israel pipol, bikos of dia sofa.
JDG 10:17 Ammon sojas kon ready to fight, so dem build dia kamp for Gilead. And Israel pipol gada kon kamp for Mizpa for Ramot.
JDG 10:18 For der, Israel pipol and di leaders kon dey ask demsef, “Who won lead us go fight Ammon pipol? Di pesin wey go lead us, go bi awa leader for Gilead.”
JDG 11:1 Jeftah na one strong man for Jabesh-Gilead. En mama na ashawo and na en papa bi Gilead.
JDG 11:2 Gilead wife for house still born oda sons for am and wen di oda sons don big, dem kon tell Jeftah, “Make yu nor tink sey yu go get any of awa papa propaty, bikos na ashawo born yu. So make yu komot awa house.”
JDG 11:3 So Jeftah komot from di house kon go stay for Tob town. Na for der e for make sturbon friends kon dey follow dem waka.
JDG 11:4 E nor too tey, before Ammon pipol kom fight Israel pipol.
JDG 11:5 Wen di fight start, Gilead leaders kon go tell Jeftah for Tob town
JDG 11:6 sey, “Make yu kom lead us go fight Ammon pipol.”
JDG 11:7 But Jeftah ansa, “Nor bi bikos una hate mi well-well, naim make una force mi komot from my papa house. Why una kom meet mi naw wen una dey trobol?”
JDG 11:8 Dem ansa, “Wi kom meet yu, bikos wi wont make yu lead all of us for Gilead go fight Ammon pipol.”
JDG 11:9 Den Jeftah tell dem, “If I follow una go fight Ammon pipol and God give mi viktory, I go bi una ruler?”
JDG 11:10 Dem ansa, “Yes! Wi agri and na God bi awa witness.”
JDG 11:11 So, Jeftah follow Gilead leaders go back and di pipol kon make am dia leader and ruler. Jeftah tell dem wetin e wont wen dem dey God present for Mizpa.
JDG 11:12 Afta, Jeftah send messenjas go meet Ammon king kon ask am, “Wetin make yu won attack awa land?”
JDG 11:13 Ammon king ansa, “Na bikos Israel pipol take my land, wen dem dey kom out from Egypt. Dem take my land wey start from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and Jordan River for west. So make una give mi back, so dat peace go dey.”
JDG 11:14 Jeftah kon send messenjas go back go meet Ammon king
JDG 11:15 sey, “Israel pipol nor take Moab and Ammon pipol land.
JDG 11:16 Wen dem komot from Egypt, dem travel pass di desert from di Red Sea till dem rish Kadesh.
JDG 11:17 Israel pipol send messenjas go meet Edom king sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land.’ But Edom king nor gri. Dem still tell Moab king di same tin, but e nor gri too. Den Israel pipol kon stay for Kadesh.
JDG 11:18 Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.
JDG 11:19 Israel pipol send messenjas go meet King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land go awa land.’
JDG 11:20 But King Sihon nor gri, instead, e gada all en sojas, go kamp for Jahza kon attack dem.
JDG 11:21 But di Oga wey bi Israel pipol God, make dem win King Sihon and en sojas. So dem kon take di land wey bi Amor pipol own.
JDG 11:22 Dem take Amor land, from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and from di desert wey dey for east go rish Jordan River for west.
JDG 11:23 Since di Oga wey bi Israel pipol God don drive Amor pipol komot bikos of en pipol, yu tink sey yu go fit just kom take am from dem?
JDG 11:24 Yu fit take anytin wey Kemosh yor god give yu, but wi go take all di land wey di Oga awa God give us.
JDG 11:25 Yu tink sey yu betta pass Balak, Zippor pikin wey bi Moab king? E try to shalenge Israel pipol, abi e nor do am? E nor ever fit fight us.
JDG 11:26 For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?
JDG 11:27 I neva do yu any bad tin, but naw, yu dey do mi bad as yu kom attack mi. Make God wey dey judge, judge today between Israel and Ammon pipol!”
JDG 11:28 But Ammon king, nor listin to Jeftah message.
JDG 11:29 Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol.
JDG 11:30 Jeftah make vow give God sey, “If Yu make mi win Ammon pipol,
JDG 11:31 anytin wey go first kom out from my house kom welkom mi, I go sakrifice am as burn ofrin give Yu.”
JDG 11:32 So, Jeftah lead en sojas go fight Ammon pipol and God gi-am viktory.
JDG 11:33 E kill Ammon pipol kon distroy about twenty towns, from Aroer go rish one aria wey near Minnit till e distroy rish Abel-Keramin. Na like dis Israel pipol take win Ammon pipol.
JDG 11:34 Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.
JDG 11:35 Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”
JDG 11:36 Naim di girl sey, “Papa, if yu make vow give God, den yu must do wetin yu vow, bikos na God give yu viktory ova yor enemies, Ammon pipol.
JDG 11:37 But first allow mi go do dis one tin: Allow mi go on-top di hill go roll and kry with my friends for two mont first, bikos I go die as virgin.”
JDG 11:38 Jeftah tell am, “Yu fit go.” So Jeftah allow am go for two monts. Di pikin and en friends kon go di hill for two monts dey kry, bikos e nor go ever born shidren.
JDG 11:39 Wen e rish house, di papa do di vow wey e make give God kon kill di girl as virgin. So dis tin kon bi tradishon for all di yong girls wey dey for Israel.
JDG 11:40 So Israel yong wimen, dey komot for four days evry year go mourn, bikos of wetin happen to Jeftah pikin.
JDG 12:1 Efraim pipol gada sojas kon cross Jordan River go Zafon. Dem send dis message go meet Jeftah, “Why yu nor koll us wen yu dey go fight Ammon pipol? Bikos of dat, wi go burn yu and yor house togeda!”
JDG 12:2 But Jeftah ansa, “I koll una wen di fight just start, but una nor gri kom join mi fight Ammon pipol!
JDG 12:3 So, as I si sey una nor gri kom, I kon risk my life go fight dem without una and God give mi viktory ova dem. So why una won kom fight mi?”
JDG 12:4 Den Efraim pipol sey, “Una, Gilead pipol, nor bi slave una bi to Efraim and Manasseh pipol?” Bikos of dat, Jeftah gada all Jabesh-Gilead men kon go attack and win Efraim pipol.
JDG 12:5 Jeftah seize di place where dem dey pass cross Jordan River and if anybody from Efraim won try cross go back, Gilead men go shalenge and ask am, “Yu bi Efraim pesin?” If di pesin say, “No, I nor kom from der,”
JDG 12:6 dem go tell am make e sey, “Shibbolet.” If e kom from Efraim, e go sey, “Sibbolet,” bikos Efraim pipol nor fit koll dat word well. Den dem go take am go kill for Jordan River korna. Na 42,000 Efraim pipol dem kill for dat time.
JDG 12:7 Jeftah lead Israel for six years, before e die and dem beri am for one of di town for Gilead.
JDG 12:8 Afta Jeftah die, Ibzan wey kom from Betlehem kon rule Israel pipol.
JDG 12:9 E get thirty sons and thirty dotas. E make en girls shidren marry men from outside en town and en boys shidren marry dia wife from anoda town too. Ibzan rule Israel pipol for seven years.
JDG 12:10 Wen e die, dem beri am for Betlehem.
JDG 12:11 Afta Ibzan die, Elon wey kom from Zebulun tribe kon rule Israel for ten years.
JDG 12:12 Wen e die, dem beri am for Aijalon for Zebulun.
JDG 12:13 Afta Elon die, Abdon wey bi Hillel pikin, wey kom from Piraton kon rule Israel pipol.
JDG 12:14 E get forty sons and thirty grand-shidren wey dey ride seventy donkey. E rule Israel pipol for eight years.
JDG 12:15 So wen e die, dem beri am for Piraton for Efraim, for Amalek pipol hill kountry.
JDG 13:1 Israel pipol sin against God again, so E kon allow Filistia pipol rule dem for forty years.
JDG 13:2 For dat time, Manoah, one man wey kom from Dan tribe, dey stay for Zorah. E nor get any pikin, bikos en wife neva born.
JDG 13:3 God angel appear to Manoah wife kon tell am, “Even doh yu neva fit born pikin, yu go soon get belle and yu go born boy.
JDG 13:4 So make yu dey kareful and make yu nor drink wine or any oda strong drink or chop any food wey dem dey forbid.
JDG 13:5 Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God as Nazirite. E go save Israel pipol from Filistia pipol hand.”
JDG 13:6 Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name.
JDG 13:7 But e tell mi sey, ‘I go get belle kon born boy.’ E still sey, ‘Make I nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid, bikos from di day wen I go born di pikin go rish di day wey e go die, dem go dedikate am give God as Nazirite.’ ”
JDG 13:8 Den Manoah pray give God, “My God! Abeg, make yor angel kom again kon tell us more tins wey wi go do about di pikin, wen dem don born am.”
JDG 13:9 God do wetin Manoah ask for and en angel kom back kon meet di woman wen e sidan for field. Dat time, en husband Manoah, nor dey with am.
JDG 13:10 So di woman run go tell en husband kwik-kwik sey, “Di man wey appear to mi dat day, don kom again!”
JDG 13:11 So Manoah get up kon follow en wife and wen e si di angel, e kon sey, “Na yu bi di man wey tok to my wife dat day?” Di angel ansa, “Yes! Na mi.”
JDG 13:12 Den Manoah sey, “If wetin yu tok so happen, wish kind tins di boy go dey do and wish kind life e go live?”
JDG 13:13 God angel ansa, “Make sure sey, yor wife do di tins wey I sey make e do.
JDG 13:14 E must nor chop anytin wey dem make from grape vine; make e nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid.”
JDG 13:15 Den Manoah tell God angel, “Abeg stay here make wi kill and kook one small goat make yu chop.”
JDG 13:16 Di angel ansa, “I go stay, but I nor go chop anytin. Instead, make yu kook and burn am as ofrin give God.” (Manoah tok like dis, bikos e nor know sey na God angel dey with am.)
JDG 13:17 Den Manoah ask God angel, “Wetin bi yor name, so dat wi go honor yu wen all dis tins don happen.”
JDG 13:18 Di angel ansa, “Why yu won know my name? My name too dey wonderful to undastand.”
JDG 13:19 Den Manoah take small goat and some korn kon offa dem for di altar on-top rock as ofrin to God wey dey do wonders.
JDG 13:20 As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun.
JDG 13:21 Na den dem kon know sey di man na God angel, so e nor appear to dem again.
JDG 13:22 Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”
JDG 13:23 But di wife ansa, “If God won kill us, E nor for asept awa burnt ofrin and E nor for appear to us kon tell us all dis wonderful tins or do dis mirakle.”
JDG 13:24 So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.
JDG 13:25 God Spirit gi-am pawa and e dey stay for Dan wey dey between Zorah and Eshtaol.
JDG 14:1 One day, Samson go Timnah, where e for si one Filistia girl and e like am well-well.
JDG 14:2 Wen e go house back, e kon tell en papa and mama, “I si one Filistia girl for Timnah wey I like, make una bring am for mi, bikos I won marry am.”
JDG 14:3 But en papa and mama nor happy. So dem ask am, “Yu nor si any woman wey yu like for awa family or di whole Israel wey yu fit marry? Why e bi sey na Filistia woman yu won marry?” But Samson tell en papa, “Make una go marry am for mi, bikos e look like betta pesin to mi.”
JDG 14:4 En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol.
JDG 14:5 Wen Samson, en papa and mama dey go Timnah, as dem pass di vineyard, one yong lion just kom attack Samson.
JDG 14:6 At wons, God Spirit make Samson strong and e tear di lion with en ordinary hand like sey na small goat. But e nor tell en papa and mama wetin happen.
JDG 14:7 Wen Samson rish Timnah, e go tok to di girl, bikos e like am.
JDG 14:8 Leta, as Samson dey go marry di girl, e kon branch go look di lion wey e kill and e sopraiz to si bee and some honey inside di lion dead body.
JDG 14:9 E take some of di honey for en hand kon dey lick am as e dey waka go. Den e take some go give en papa and mama. Dem lick am, but Samson nor tell dem sey na from lion dead body e for take am.
JDG 14:10 Wen Samson papa dey make di final arrangement for di marriage, Samson kon do party for der, bikos dis na wetin di yong men dem dey do.
JDG 14:11 Wen di girl papa si am, dem selet thirty men for di town make dem stay with am.
JDG 14:12 So Samson tell dem, “Make I tell una one problem, if una fit solve am for di next seven days, I go give una thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.
JDG 14:13 But if una nor fit solve am, una go give mi thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.” So dem kon gri.
JDG 14:14 Samson tell dem, “Di pesin wey chop, na-im dey bring wetin dem go chop and na from wetin strong, sweet tin for dey kom out.” Afta three days, dem neva still fit solve am.
JDG 14:15 For di fourt day, dem kon tell Samson wife to bi, “Deceive yor husband to bi, so dat e go tell yu di ansa of wetin e tell us; if not, wi go burn yu and yor papa family togeda, bikos e bi like sey yu invite us kom here, so dat wi go dey poor.”
JDG 14:16 So Samson wife to bi kry go meet am sey, “Yu nor love mi; yu hate mi! Yu tell my pipol sometin and yu neva tell mi di ansa.” But Samson tell am, “I neva even tell my papa and mama di ansa, so wetin go make mi tell yu?”
JDG 14:17 Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.
JDG 14:18 So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey, “Na wetin go fit dey sweet pass honey or wish tin or animal strong pass lion?” But Samson ansa dem, “If to sey, una nor work with my melu, una nor for know di ansa.”
JDG 14:19 At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.
JDG 14:20 So dem kon give Samson wife to bi to Samson best man for di marriage.
JDG 15:1 For di time wen dem dey harvest wheat, Samson kon take one small goat go visit en wife to bi. Wen e rish der, e tell en wife papa, “I won go my wife room.” But di papa nor gri.
JDG 15:2 Den di man tell Samson, “I bin tink sey yu hate my dota, so I kon gi-am to yor best man as en wife. But si, en yonga sista fine pass am well-well. Yu fit marry dat one.”
JDG 15:3 But Samson sey, “Dis time, dem nor go blame mi for wetin I go do Filistia pipol.”
JDG 15:4 So e go outside kon go katch 300 fox, e tie dia tail two-two togeda with rope.
JDG 15:5 Den e lite fire put for di rope wey dey dia tail kon porshu dem enter Filistia pipol farm and dem burn all wetin dem plant for di farm rish groun. E even still distroy dia vineyards and olive trees.
JDG 15:6 So Filistia pipol ask, “Who do dis tin?” Dem kon sey, “Na Samson, bikos en fada-in-law to bi wey kom from Timnah, give di woman to en best man.” So Filistia pipol vex kon go burn di girl, en papa and dia house rish groun.
JDG 15:7 Samson tell dem, “Na so una dey bihave! I swear, I nor go stop until I pay una back!”
JDG 15:8 So e attack dem with vexnashon kon kill many of dem. Afta, e kon go stay for inside rock for Etam kave.
JDG 15:9 Filistia pipol kom kamp for Judah, near Lehi town.
JDG 15:10 Den, Judah men ask Filistia pipol, “Wetin make una won fight us?” Den Filistia pipol ansa, “Wi wont Samson. Wi kom pay am back for wetin e do us.”
JDG 15:11 So 3,000 men from Judah go di kave for di rock for Etam, go meet Samson kon tell am, “Yu nor know sey na Filistia pipol dey rule us? Wetin yu do to us so?” Samson ansa dem, “I pay dem back for wetin dem do mi.”
JDG 15:12 But dem tell am, “Wi kom here kon tie yu, so dat wi go karry yu give dem.” So Samson sey, “Okay! But make una promise mi sey, una nor go kill mi by unasef.”
JDG 15:13 Dem gri kon sey, “Wi nor go kill yu; na only tie wi won tie yu karry give dem.” So dem tie am with two new rope kon karry am komot from di rock.
JDG 15:14 As Samson rish Lehi, Filistia sojas kom dey happy dey shaut. At wons, God pawa enter Samson and e kut di rope wey dem take tie am like sey na tread wey dey burn.
JDG 15:15 One donkey wey dem just kill, Samson si en bone for groun. So e pick di bone kon use am kill 1,000 Filistia sojas.
JDG 15:16 Den Samson sey, “Na with donkey bone I take kill 1,000 men kon gada dia bones togeda.”
JDG 15:17 Afta e don boast finish, e trowey di bone kon koll di place, “Bone Hill.”
JDG 15:18 Leta, Samson kon dey hongry for wota, den e kry give God sey, “Yu give mi dis viktory finish, make dis wiked Filistia pipol kon katch and kill mi, bikos wota dey hongry mi?”
JDG 15:19 So God allow wota kom out from one place for di groun for Lehi, den Samson drink until e beleful. So e kon koll di place “En-Hakkore” and e still dey for Lehi till today.
JDG 15:20 Samson lead Israel pipol for twenty years, even doh Filistia pipol still dey rule di land.
JDG 16:1 One day, Samson go Gaza wey bi Filistia pipol town and e stay der thru-out with one ashawo.
JDG 16:2 Gaza pipol kon know sey, Samson dey for der, so dem gada for di town gate dey wait for am till day break. Dem sidan kwayet dey tok for dia mind sey, “If morning rish, wi go kill-am.”
JDG 16:3 But Samson stay bed go rish mid-nite, den e get up go di town gate pul am with di two pila kon karry am for en shoulder go Hebron hill.
JDG 16:4 Afta sometaim, Samson kon love one woman wey en name na Delilah, wey dey stay for Sorek Valley.
JDG 16:5 All di five rulers for Filistia go meet Delilah kon sey, “Make yu deceive Samson, so dat e go tell yu wetin make am dey strong and how dem fit take stop am. Den yu go find way take tie am with rope well-well. Afta evritin, each of us go give yu 1,000 one hundred silva.”
JDG 16:6 So Delilah go meet Samson kon tell, “Abeg, make yu tell mi, ‘Wetin make yu dey strong like dis and wetin pesin go fit do, if e won tie yu?’ ”
JDG 16:7 Den Samson ansa, “If dem tie mi with seven new strong rope wey nor dry, I go dey weak well-well.”
JDG 16:8 So Filistia rulers bring seven new strong rope kon give Delilah, den e use am take tie Samson.
JDG 16:9 By dat time, Delilah hide some men for di oda room, den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu o-o!” But Samson kut di rope, just as tread dey kut if yu take fire tosh am. So dem nor still know di sekret wey make am get pawa.
JDG 16:10 Leta, Delilah kon tell Samson, “Si, yu dey lie for mi kon make mi bi like fool! Abeg, make yu tell mi di trut, na how dem fit take tie yu?”
JDG 16:11 Samson ansa am, “If dem tie mi with new rope wey dem neva use before, I go weak well-well.”
JDG 16:12 So Delilah take new rope kon tie am. Di men dey di oda room dey wait, so e kon shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu!” But e kut di rope komot for en hand like sey na tread.
JDG 16:13 Den Delilah tell am, “Yu still dey lie and fool mi! So naw, make yu tell mi how pesin fit take tie yu.” Den Samson ansa am, “If yu plait my hair into seven part kon use peg take make am tit, I go dey weak well-well.” So wen Samson dey sleep, Delilah kon plait di hair into seven part.
JDG 16:14 Den e tit am with di peg. E kon shaut again, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu o-o!” So Samson wake-up, remove di peg, den luz en hair.
JDG 16:15 Den Delilah vex kon tell am, “Why yu dey tell mi sey, ‘I love yu’ and yu nor fit trust mi kon tell mi yor sekret? Yu don fool mi three times naw and yu neva still tell mi wetin make yu dey strong!”
JDG 16:16 Delilah kontinue to dey tok and komplain until Samson kon taya for en wahala,
JDG 16:17 so e tell am di trut at last. E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”
JDG 16:18 Delilah just know sey Samson don tell am di trut, so e send message go give Filistia rulers sey, “Make una kom back just dis last time, bikos e don tell mi di trut.” So dem bring di money follow body kom.
JDG 16:19 Delilah deceive Samson sleep for en lap, den koll one man make e kut di seven hair komot. Den e put am for groun small-small, bikos en pawa don leave am.
JDG 16:20 Den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu!” E wake-up kon tell ensef, “I go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga God don leave am.
JDG 16:21 So Filistia pipol katch am kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force am make e dey grind korn for prison.
JDG 16:22 But e nor too tey, before en hair kon dey grow kom again.
JDG 16:23 Filistia rulers dey do party, offa sakrifice and dey praiz dia god wey bi Dagon kon dey sey, “Awa god don give us viktory ova Samson wey bi awa enemy!”
JDG 16:24 Wen di pipol si am, dem praiz dia god sey, “Awa god don diliver awa enemy give us! Di pesin wey kill many of awa pipol don dey under awa pawa naw!”
JDG 16:25 Many of dem don drink by naw, so dem sey, “Make una bring Samson kom out make e kon make us laf!” So dem bring am kom out from di prison and e stand between di two pila wey dey support di building. Dem kon dey play with am, so dat e go make dem laf.
JDG 16:26 Den Samson tell di boy wey hold en hand sey, “Make yu put my two hand for di pila wey hold di temple, bikos I won rest my body.”
JDG 16:27 By dis time, di temple don already full with pipol. All di five Filistia rulers dey der and about 3,000 men and wimen dey der dey wosh Samson as e dey make dem laf.
JDG 16:28 Den Samson pray give God sey, “Oga God wey get pawa, remember mi again. My God! Abeg make Yu give mi pawa one more time. Make I pay Filistia pipol back for my eye wey dem blind.”
JDG 16:29 Samson put en two hand for di pila wey hold di temple kon push am,
JDG 16:30 den e pray sey, “My God, make Yu allow mi die with Filistia pipol wey bi my enemies.” Den di temple fall skata for di five rulers and di pipol head. Di pipol wey Samson kill wen e dey die, many pass di ones wey e kill wen e dey alive.
JDG 16:31 Afta, en brodas and family kon karry en dead body. Dem take am go beri between Zorah and Eshtaol, where dem beri en papa Manoah put. Samson lead Israel pipol for twenty years.
JDG 17:1 E get one man, e name na Mikaya and e dey stay for Efraim hill kountry.
JDG 17:2 One day, e tell en mama, “Yor 1,000 one hundred silva wey dem tif wey kon make yu curse di tif, dey my hand.” Na mi tif am. Den en mama sey, “Bikos yu gri sey na yu tif am, make God bless yu!”
JDG 17:3 So e give di money back to en mama, den di mama sey, “Bikos I nor wont make di curse follow my pikin, I dey dedikate dis money give God. I go use am take buy wood kon make juju wey dem kover with silva.”
JDG 17:4 So wen di pikin give en mama di money, di woman take two hundred silva kon give pesin wey turn am to juju and dem kon put am for Mikaya house.
JDG 17:5 So, Mikah build shrine for di juju, den e make one priest garment kon wear am for en pikin, so dat e go bi en priest.
JDG 17:6 Dat time, Israel pipol nor get king; so all di pipol dey do wetin dem like.
JDG 17:7 One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.
JDG 17:8 E komot for Betlehem go look for anoda place where e go stay. Wen e dey travel, e kon rish Mikah house for di hill kountry wey dey Efraim.
JDG 17:9 Mikah ask am, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I bi Levi from Betlehem for Judah and I dey look for where to stay.”
JDG 17:10 So, Mikah tell am, “Yu fit stay here with mi and yu go bi my papa and priest. Evry year, I go dey give yu ten silva, klot and food.”
JDG 17:11 Di Levi man gri and e kon bi priest like Mikah pikin too.
JDG 17:12 So e stay Mikah house and Mikah kon make di man e own pesinal priest.
JDG 17:13 Den Mikah sey, “I know sey God go bless mi naw, bikos I get Levi pesin as my priest.”
JDG 18:1 Dat time, Israel pipol nor get king. And Dan tribe dey find where dem go stay, bikos dem neva fit pak go di land wey dem divide give dem, wen dem dey divide land give all di tribe for Israel.
JDG 18:2 So Dan pipol choose five strong warrior from Zorah and Eshtaol town, so dat dem go find land where dem go stay. Wen dis men rish Efraim hill kountry, dem kon go stay for Mikah house till di next day.
JDG 18:3 As dem dey Mikah house, dem notis di Levi priest for der, so dem kon ask am, “Na who bring yu kom here? Na wetin yu dey do for here and wetin make yu dey here?”
JDG 18:4 E ansa dem, “I get agriment with Mikah, to bi en pesinal priest and e dey pay mi.”
JDG 18:5 Den dem tell am, “Ask God for us weda awa journey go get head.”
JDG 18:6 Di priest tell dem, “Make una go in peace, bikos God dey with una for di journey.”
JDG 18:7 So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.
JDG 18:8 Wen di men kom back to Zorah and Eshtaol, dia pipol kon ask dem, “Wetin una find?”
JDG 18:9 Dem ansa, “Make una kom, make wi attack dem! Wi don si di land and e dey very good. Wetin una dey wait for? Make wi nor waste time, make wi go take am.
JDG 18:10 Wen wi rish der, una go si sey di pipol dey leave eazy life. Di land big well-well and e get evritin wey pesin wont. God don gi-am to us.”
JDG 18:11 So six hundred men from Dan tribe wey ready for war kon komot go Zorah and Eshtaol.
JDG 18:12 Dem kamp for Kiriat-Jearim west for Judah and na dis make dem dey koll di place Dan till today.
JDG 18:13 Dem from der pass go Mikah house for Efraim hill kountry.
JDG 18:14 Den di five men wey go spy Laish land kon tell di oda pipol, “Dis house wey una dey si so, get holy garment and some oda juju wey dem karve, dey der too. Wetin una wont make wi do?”
JDG 18:15 So dem enter Mikah house where di yong priest dey stay kon greet am well.
JDG 18:16 As di six hundred men from Dan tribe wey ready to fight war, stand for di gate to enter di kompond,
JDG 18:17 di five men wey go spy, enter di shrine karry di image wey dem karve, di efod and di juju dem. While di priest stand for di gate with di six hundred men.
JDG 18:18 Wen di priest si sey di men dey karry di holy tins dey komot from di shrine, e kon ask dem, “Wetin una dey do so?”
JDG 18:19 Dem ansa am, “Kwayet and make yu follow us kon bi awa papa and priest. E nor good sey make yu bi priest for Israel tribe and family, down for one man?”
JDG 18:20 So di priest happy kon follow dem and e karry all di holy tins.
JDG 18:21 Dem kon dey go with dia shidren, animals and all wetin dem get.
JDG 18:22 Wen Dan pipol don go far from Mikah house, Mikah kon koll all en neighbours make dem follow am porshu Dan pipol.
JDG 18:23 Dem porshu Dan pipol katch. Den, Dan men turn back kon ask Mikah, “Wetin happen? Why yu koll all dis men make dem porshu us like dis?”
JDG 18:24 Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”
JDG 18:25 So Dan men tell am, “Mind wetin yu dey tok! Unless yu wont make all dis men attack kon kill yu and yor family.”
JDG 18:26 Den, Dan pipol kon waka dey go. Wen Mikah si sey di pipol too many for am to attack, e kon leave dem go back to en house.
JDG 18:27 Afta Dan pipol don take Mikah holy tins and priest, dem kon rish Laish land where di pipol dey kwayet well-well. Dem attack dem with swod kon burn di town rish groun.
JDG 18:28 Nobody dey to save dem, bikos dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor get any business with oda pipol. Den, Dan tribe build di place kon dey stay der. And dis tin happen for di valley near Bet-Rehob.
JDG 18:29 Dem shange di town name from Laish to Dan, bikos of dia grand-grand papa wey bi Jakob pikin.
JDG 18:30 Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin, dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go Babilon.
JDG 18:31 So Mikah juju dey der, as long as God Tabanako dey for Shiloh.
JDG 19:1 For dat time, Israel pipol nor get king. But e get one man from Levi tribe wey dey stay for Efraim hill kountry. One day, e bring one girl kom from Betlehem for Judah as en girl-friend.
JDG 19:2 But di girl dey vex for am, so e kon go back to en papa house for Betlehem. Afta four monts don pass,
JDG 19:3 en boy-friend kon go Betlehem go tok to am make e kom back. E take en savant and two donkey follow body. Wen e rish di girl papa house, di papa kon welkom am.
JDG 19:4 Di papa beg am make e stay small, so e stay der; chop, drink and sleep for three days.
JDG 19:5 For di fourt day, di man kwik wake-up kon ready to go, but di girl papa tell am, “Make yu chop sometin, before yu go.”
JDG 19:6 So di two men sidan kon chop and drink, den di papa kon sey, “Abeg stay for just dis nite make yu enjoy yorsef.”
JDG 19:7 Di man stand up won kon go, but di papa still dey beg make e stay, so e kon agri to stay for dat nite.
JDG 19:8 For di fift day, e kon kwik wake-up make e dey go. Again, di girl papa kon sey, “Make yu chop sometin; den yu fit go for aftanoon.” So dem sidan kon chop.
JDG 19:9 Afta, wen di man, en girl-friend and en savant dey ready to go, di papa kon sey, “Look, evening don almost rish. Make una stay and enjoy for dis nite, den tumoro morning, una fit get up early kon go.”
JDG 19:10 But dis time, di man don make up en mind to go. So e take en two donkey and en girl-friend kon pass thru Jebus (wey bi Jerusalem).
JDG 19:11 Time don go far before dem rish Jebus, so di man savant tell am, make wi stop for Jebus town kon sleep for der.
JDG 19:12 But di masta sey, “No! Wi nor go fit stay for dis town wey Israel pipol nor dey, instead wi go-go Gibeah.
JDG 19:13 Make wi waka fast, so dat wi go fit rish Gibeah or Rama, den wi go sleep for any of di towns.”
JDG 19:14 So dem kontinue. Evening don dey rish wen dem rish Gibeah town for Benjamin land,
JDG 19:15 so dem stop kon sleep for der. Dem sleep for di town hall, bikos nobody allow dem sleep for dia house.
JDG 19:16 Dat evening, one old man just dey kom back from farm where e for go work. E kom from Efraim tribe, but e dey stay for Gibeah, wey all di pipol kom from Benjamin tribe.
JDG 19:17 Wen e si dem sidan for di town hall, e kon ask dem, “Where una from kom and where una dey go.”
JDG 19:18 Di Levi man ansa, “Wi dey kom from Betlehem for Judah and wi dey go di oda side for Efraim hill kountry, bikos na der wi dey stay. I travel go Betlehem before and naw I dey go back to my house. But nobody gri make wi sleep for dia house dis nite,
JDG 19:19 even doh sey wi get evritin wey wi wont. Wi get food for awa donkey, plenty bread and wine for awasef.”
JDG 19:20 Den di old man sey, “Make una kom my house, I go give una anytin wey una wont. Una nor nid to stay for di town hall.”
JDG 19:21 So e take dem go en house kon feed dia donkey. Afta dem don wosh dia leg, dem kon chop and drink togeda.
JDG 19:22 As dem dey chop and drink, some pipol wey dey kause trobol for di town kon surround di house. Dem bigin nok di door dey shaut for di old man, “Make yu bring di man wey dey stay with yu, so dat wi go sleep with am.”
JDG 19:23 But di old man go outside go meet dem kon tell dem, “No! My brodas, abeg make una nor do dis kind evil tin! Dis man na my visitor and dis kind tin na shame.
JDG 19:24 Look, make una take my dota wey bi virgin and di man girl-friend. I go bring dem kom out for una, make una take dem do wetin una like, but make una nor do dis kind bad tin to di man.”
JDG 19:25 But dem nor gri listin to di man. So di Levi kon push en girl-friend go outside for dem. So dem rape am, do am anyhow till day break.
JDG 19:26 Wen day break, di woman kom di old man house where en boy-friend dey kon fall for di gate, e stay der until sun kom out for morning.
JDG 19:27 Wen di boy-friend open door for morning make e dey go, e si en girl-friend liedan for der and e hand dey di door-mot.
JDG 19:28 So e tell am, “Make yu get up make wi dey go!” But di woman nor ansa. So e karry am put for en donkey kon take am go house.
JDG 19:29 Wen e rish house, e take knife kon kut en girl-friend body into twelf part, den e send one part go each of di twelf tribe for Israel.
JDG 19:30 Evribody wey si am kon sey, “Wi neva hear dis kind tin before! Dis kind tin neva happen wons since Israel pipol komot from Egypt! Wi nid to do sometin about am! So dem kon dey tok among demsef dey ask, ‘Na wetin wi go do naw?’ ”
JDG 20:1 Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.
JDG 20:2 Di leaders for all di tribe for Israel dey with God pipol too and dem bi 400,000 sojas.
JDG 20:3 By dat time, Benjamin pipol don hear sey all di oda tribe for Israel, don gada for Mizpa. Israel pipol kon ask, “Make una tell us how dis bad tin take happen?”
JDG 20:4 So di Levi wey dem kill en girl-friend kon sey, “Mi and my girl-friend go spend one nite for Gibeah, wey bi Benjamin pipol town.
JDG 20:5 Dat nite, some men for Gibeah kon surround di house won kon kill mi. Dem kon rape my girl-friend until e die.
JDG 20:6 So I take en body, kut am into twelf part, den I send one-one go each tribe for Israel. Dis pipol don do evil and wiked tin.
JDG 20:7 So naw, Israel pipol must decide wetin wi go do about dis tin!”
JDG 20:8 All di pipol get up di same time kon sey, “Non of us go-go house back!
JDG 20:9 Dis na wetin wi go do Gibeah pipol; wi go pick pipol wey go attack dem.
JDG 20:10 Wi go still pick one out of evry ten from di men for each tribe, wey go dey supply di sojas food, den wi wey remain go attack Gibeah for Benjamin town, bikos of wetin dem do to Israel.”
JDG 20:11 So Israel pipol gada with one mind to go attack Gibeah town.
JDG 20:12 Israel pipol send message go Benjamin tribe sey, “Wetin bi dis wiked tin wey una do so?
JDG 20:13 Make una release doz wiked men, di trobol-makers from Gibeah, so dat wi go kill dem take klean Israel land from dis bad tin wey una do.” But Benjamin pipol nor gri.
JDG 20:14 Instead dem komot from dia towns kon gada for Gibeah to fight Israel pipol.
JDG 20:15 Dem koll 26,000 sojas from all dia town and 700 special men wey dey stay der.
JDG 20:16 Di 700 men dey use left hand and each of dem dey stone without sey dem miss.
JDG 20:17 Israel pipol get 400,000 sojas wey dem don train.
JDG 20:18 Before dem go for di war, Israel pipol go Bethel go ask God, “Na wish tribe go first attack Benjamin pipol?” God ansa, “Make Judah go first.”
JDG 20:19 So Israel pipol kwik komot for early morning go kamp near Gibeah.
JDG 20:20 Den dem mash go Gibeah go attack Benjamin men.
JDG 20:21 But Benjamin sojas wey dey guide di town kom kill 22,000 Israel pipol dat day.
JDG 20:22 Israel pipol enkourage each oda kon stay for di same place where dem for fight before.
JDG 20:23 Bikos dem don go Bethel go kry for God present till evening kon dey sey, “Make wi fight against awa rilative for Benjamin tribe again?” God ansa dem, “Make una go fight dem.”
JDG 20:24 So di next day, dem kon go fight against Benjamin men,
JDG 20:25 but Benjamin men still kill anoda 18,000 Israel pipol wey sabi fight well-well.
JDG 20:26 Den all Israel pipol kon go Bethel again go kry and fast for God present till evening. Dem still bring burnt ofrin and peace ofrin kon give God.
JDG 20:27 Israel pipol kon dey ask for direcshon from God (bikos before-before, God Kovenant Box dey for Bethel
JDG 20:28 and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?” God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”
JDG 20:29 So dem kon set trap round Gibeah.
JDG 20:30 Israel pipol kon attack Benjamin tribe for di third day and dem kamp for Gibeah just as dem do before.
JDG 20:31 Wen Benjamin pipol kom out kon fight, dem lead dem komot for di town. Just as before, dem bigin kill some Israel pipol, dem kill rish thirty Israel pipol for di open land and di road wey dem dey pass go Bethel and Gibeah.
JDG 20:32 Den Benjamin sojas shaut, “Wi dey win dem, just as wi do before!” But Israel pipol don plan before sey, dem go run komot from di town, so dat Benjamin men go porshu dem enter road.
JDG 20:33 Wen Israel main sojas rish Baal-Tamar, dem take dia pozishon, while di ones wey surround west for Gibeah rush kom out wons from where dem hide put kon attack.
JDG 20:34 Na 10,000 special sojas wey dem choose from Israel tribe kon attack Gibeah. Di fight strong well-well sotey Benjamin sojas nor know sey dem go soon distroy dem finish.
JDG 20:35 God help Israel pipol win Benjamin pipol and dat day, Israel pipol kill 25,000 men wey bi di best sojas for Benjamin tribe.
JDG 20:36 Den Benjamin sojas kon know sey, dem don luz. Israel main sojas bin dey run from Benjamin sojas, bikos dem won give doz wey still hide for bush, di shance to attack Gibeah town.
JDG 20:37 Den doz wey hide, rush kom out kon kill evribody for di town.
JDG 20:38 Dem don arrange sey, dem go send big kloud of smoke from di town as signa.
JDG 20:39 Wen Israel pipol si di smoke, dem turn kon attack Benjamin sojas. By dat time, Benjamin sojas don kill thirty Israel sojas, so dem kon sey, “Wi don dey win dem, just as wi do for di first fight!”
JDG 20:40 But wen Benjamin sojas look back kon si sey smoke dey go up from evriwhere for di town,
JDG 20:41 Israel sojas kon bigin attack dem. Naw, Benjamin sojas kon dey fear, bikos dem know sey, dem don die finish.
JDG 20:42 So dem turn kon dey run from Israel sojas go di open land, but dem nor fit eskape di fight and dem kill all di pipol wey kom out from di town wey dey near der too.
JDG 20:43 Israel sojas set trap for dia enemies and dem porshu dem sotey go rish Gibeah east kon dey kill dem as dem dey go.
JDG 20:44 Dat day, Benjamin 18,000 strong sojas die for di war.
JDG 20:45 Di ones wey manage survive run enter wildaness near Rimon Rock, but Israel sojas kill 5,000 for di road side. Dem porshu dem, until dem kill anoda 2,000 near Gidom.
JDG 20:46 So dat day, Benjamin tribe lost 25,000 strong sojas.
JDG 20:47 Di sojas wey remain na di six hundred wey run go Rimon Rock and dem stay der for four monts.
JDG 20:48 Israel pipol still go back go kill Benjamin pipol wey remain; di men, wimen, shidren and even all di animals. Dem burn all di towns for der.
JDG 21:1 Wen Israel pipol gada for Mizpa, dem kon vow sey, “Wi nor go ever marry awa dotas give Benjamin tribe.”
JDG 21:2 So dem go Bethel, sidan for God present till evening kon dey kry well-well.
JDG 21:3 Dem sey, “Awa Oga wey bi Israel God! Wetin make dis kind tin happen for Israel? Naw one of awa tribe don dey miss from Israel!”
JDG 21:4 Di next day for early morning, di pipol build altar kon bring dia burnt and peace ofrin kom.
JDG 21:5 Den dem sey, “Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?” By dat time, dem don swear before God sey, anybody wey nor gri kom, dem go kill-am.
JDG 21:6 So Israel pipol kon dey sorry for dia broda, Benjamin tribe den dem kon sey, “Today, Israel don lost one of en tribe.
JDG 21:7 How wi go fit take find wife for di pipol wey remain, since wi don swear with God sey, wi nor go give dem awa dotas marry?
JDG 21:8 Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa.
JDG 21:9 Bikos wen dem kount all di pipol finish, dem si sey nobody for Jabesh dey der.
JDG 21:10 So di pipol kon send anoda 12,000 for dia best sojas go Jabesh town for Gilead sey, make dem kill evribody, even di wimen and shidren.
JDG 21:11 Dem sey, dis na wetin una go do, “Kill all di sons and any woman wey nor bi virgin.”
JDG 21:12 For all di pipol wey dey Jabesh, dem si 400 yong virgin wey neva sleep with man before kon bring dem kom di kamp for Shiloh wey dey Kanaan land.
JDG 21:13 Den di pipol send message go give di pipol wey remain for Benjamin tribe, wey dey stay for Rimon Rock.
JDG 21:14 So Benjamin men go back to dia house and Israel pipol kon give dem di girls from Jabesh wey dem nor kill make dem marry. But dem nor many rish.
JDG 21:15 Di pipol sorry for Benjamin pipol, bikos God don separate dem from di oda Israel tribes.
JDG 21:16 So di leaders kon ask, “How wi fit take find wife for di pipol wey remain, since all Benjamin wimen don die finish?
JDG 21:17 Bikos doz wey survive for Benjamin tribe must get shidren, so dat one tribe for Israel nor go die finish.
JDG 21:18 But wi nor go fit marry awa dotas give dem, bikos wi don swear sey anybody wey do am go dey under God curse.”
JDG 21:19 Den, dem tink of di sakrifice wey dem dey do for God and na evry year for Shiloh, wey dey sout for Lebonah and nort for Bethel, dem for dey do am. E still dey east for di road wey dey between Bethel and Shekem.
JDG 21:20 So dem tell Benjamin men wey still nid wife sey, “Make una go hide for di vineyards.
JDG 21:21 Anytime una si di yong wimen for Shiloh kom out kon dance for di festival, una go rush kom out kon katch dem one-by-one go house for Benjamin town as una wife!
JDG 21:22 Den wen dia papa and brodas kom meet us with vexnashon, wi go tell dem sey, ‘Abeg make una sorry for us. Make una allow dem marry una dotas, bikos wi nor fit find wife for all of dem wen wi distroy Ramot. And nor-tin go do una if una break di vow, bikos una nor really marry una dotas give dem from una mind.’ ”
JDG 21:23 So Benjamin men do as dem tell dem. Each man katch one woman as dem dey dance for di festival kon karry am go as en wife. Dem go back to dia own land kon build house and stay der again.
JDG 21:24 Den Israel pipol komot from der. Evry man go back to en tribe, family and evritin wey e get.
JDG 21:25 For dat time, Israel nor get king; so evribody dey do wetin dem tink sey dey good for dia eye.
RUT 1:1 For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.
RUT 1:2 (Di man name na Elimelek and en wife name na Naomi. E get two shidren wey bi Mahlon and Kilion. Dem kom from Efrat family wey dey Betlehem for Judah.)
RUT 1:3 Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin.
RUT 1:4 So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years.
RUT 1:5 Den Naomi two sons, Mahlon and Kilion kon die too. So Naomi nor get husband or shidren again.
RUT 1:6 So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.
RUT 1:7 So, wen en and en two pikin wife komot for where dem dey stay kon dey go back to Judah,
RUT 1:8 Naomi kon tell di wimen, “Make una listin to mi! Make una go back to una mama house! Make God show una en favor just as una don show am to mi and my shidren wey don die!
RUT 1:9 Make God guide una for una new husband house!” Den e kiss dem kon sey bye-bye and dem kon dey kry.
RUT 1:10 But di wimen tell am, “No! Wi go follow yu go meet yor pipol.”
RUT 1:11 So Naomi ansa dem, “My dotas! Make una dey go house! No nid to follow mi go back to Judah! I nor go fit born pikin wey go bi una husband again!
RUT 1:12 My dotas, make una dey go house! I don old well-well to marry again. Even if I feel sey hope still dey to marry dis nite kon get belle born pikin,
RUT 1:13 true-true una nor go won wait until dem big rish to marry una! Una nor go fit stay thru-out dat time without husband. Yes! Una nor go fit wait. So my dotas, make una nor follow mi go, bikos my wahala and sofa too many for una to karry and na God dey ponish mi!”
RUT 1:14 Dem kon kry well-well again. Den Orpah kiss Naomi kon go back, but Rut nor gri go.
RUT 1:15 So Naomi tell am, “Si, yor husband broda wife dey go back go meet en pipol and en god. So make yu follow yor husband broda wife go back!”
RUT 1:16 But Rut ansa, “Nor force mi sey make I leave yu! Anywhere wey yu go, na der I go-go. Anywhere wey yu won stay, na der I go stay. Yor pipol go bi my pipol and yor God go bi my God.
RUT 1:17 Where yu for die, I go die for der too and na der dem go beri mi put. Make God ponish mi well-well if I nor do wetin I promise! Na only deat go fit separate mi from yu!”
RUT 1:18 Wen Naomi si sey Rut sirious to follow am go, e kon stop to tell am make e go back.
RUT 1:19 So dem two kon travel until dem rish Betlehem. As dem rish der, di whole village happy sey dem kom. Di wimen for di village kon sey, “Na Naomi bi dis?”
RUT 1:20 Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well.
RUT 1:21 I komot here with my husband and shidren, but God don make mi kom back with empty hand. Wetin make una dey koll mi, ‘Naomi,’ wen una si sey God tok against mi and di One wey get pawa don make mi dey sofa?”
RUT 1:22 So na like dis Naomi take kom back from Moab with Rut, en pikin, Mahlon wife. Dem rish Betlehem wen grain harvest just dey start.
RUT 2:1 E get one man wey rilate to Naomi husband, Elimelek family and en name na Boaz. E get money well-well and pipol know am for evriwhere for Betlehem.
RUT 2:2 One day, Rut wey kom from Moab kon tell Naomi sey, “Abeg, make I go di field go gada rice. I dey sure sey I go si pesin wey go let mi work with am.” Naomi kon ansa, “My pikin! Yu fit go.”
RUT 2:3 So Rut kon go gada rice for di field wey bi Boaz, wey kom from Elimelek family, own.
RUT 2:4 For dat time, Boaz kom Betlehem kon greet di workers sey, “Make God dey with una!” Dem ansa, “Make God bless yu too!”
RUT 2:5 Wen Boaz si Rut, e kon ask en savant wey dey show dem wetin to do sey, “Na where dis woman from kom?”
RUT 2:6 Di savant ansa, “Na di Moab woman wey follow Naomi kom back.
RUT 2:7 E ask us, ‘Weda e fit follow di workers gada rice?’ And na since morning wey e kom e dey work hard kom rish na. E nor dey rest at-all.”
RUT 2:8 So Boaz tell Rut, “My pikin! Si, make yu listin well-well! Make yu nor komot here go gada rice for anoda farm. Yu nor nid to go anoda farm. Yu fit dey here work with my workers wey bi wimen.
RUT 2:9 Look di farm wey di men for dey work, den follow di wimen for back. I go tell di men make dem nor trobol yu. Wen wota dey hongry yu, yu fit go di wota pot go drink from di wota wey di savants fetch.”
RUT 2:10 Rut knee down face groun for Boaz front kon sey, “Wetin make yu dey good and kare for mi, even doh yu know sey I bi strenja?”
RUT 2:11 Boaz ansa, “Dem don tell mi evritin wey yu dey do for yor moda-in-law since wey yor husband die. How yu leave yor papa and mama and yor kountry kon stay with pipol wey yu nor know before.
RUT 2:12 God go bless yu for evritin wey yu dey do! Di Oga wey bi Israel God wey dey protet yu, go pay yu for all di good tins wey yu don do!”
RUT 2:13 Rut kon sey, “My oga, yu really dey good to mi, bikos yu don trit mi like yor savant, even doh I nor bi yor savant!”
RUT 2:14 For di time wey dem won chop food for aftanoon, Boaz kon tell Rut, “Make yu kom chop some food! Make yu drink some wine too as yu dey chop yor bread!” So Rut sidan near di oda workers. Den Boaz give Rut some rice wey dem roast. Rut chop beleful, den kon keep di rest.
RUT 2:15 Wen Rut stand up won go gada rice, Boaz kon tell en savants, “Make una let am gada rice for where rice many and make una nor stop am!
RUT 2:16 Apart from dat, make una put many rice head for groun, so dat e go si gada and make nobody stop am!”
RUT 2:17 So Rut kon gada rice for di farm till evening. So, wen Rut look all wetin e gada, e heavy rish three pounds!
RUT 2:18 Rut karry di rice wey e gada kon go house and en moda-in-law kon si di rice wey e bring kom. Den Rut give Naomi di rice wey dem roast wey e chop remain for aftanoon.
RUT 2:19 Naomi ask am, “Na where yu for gada rice today? Na where yu for go work? Make God bless di pesin wey do dis kind tin for yu!” So Rut kon tell en moda-in-law who e work for. E sey, “Di man wey I follow work today, en name na Boaz.”
RUT 2:20 Naomi kon tell Rut, “Make God bless am well-well, bikos God always dey keep en promise to doz wey dey alive and doz wey don die!” Naomi kon tell Rut, “Dis man rilate to us and na senior man for awa family.”
RUT 2:21 Rut kon ansa, “Di man even tell mi sey, ‘Work with my savants until dem don gada evritin finish!’ ”
RUT 2:22 Naomi kon tell Rut, “My pikin, e good as yu dey work with en wimen savants. For der, nobody go wahala yu, just as dem fit do for anoda farm.”
RUT 2:23 So Rut start to work with Boaz wimen workers kon dey gada rice with dem until di harvest finish. Afta dat time, Rut kon stay house with en moda-in-law.
RUT 3:1 For dat time, Naomi kon tell Rut, “My pikin, I must find betta house for yu, so dat yu go dey sikure.
RUT 3:2 Yu si, Boaz wey yu dey work with en wimen savants, na awa relashon. Si, e won blow kanda komot from en rice dis nite.
RUT 3:3 So make yu baf well-well, rub oil wey dey scent kon dress well. Den go where e for dey work. But nor let am know sey yu dey der until e don chop finish.
RUT 3:4 Wen e don ready to go sleep, look di place wey e go sleep put. Den pul di klot e take kover en leg make yu sleep near am. E go tell yu wetin yu go do.”
RUT 3:5 Rut kon ansa Naomi, “I go do evritin wey yu tok.”
RUT 3:6 So Rut go where Boaz dey kon do evritin wey en moda-in-law tell am make e do.
RUT 3:7 Wen Boaz don chop beleful, e kon go sleep for di end for where dem gada di rice put. Den Rut small-small waka go der, open en leg kon sleep near am.
RUT 3:8 For mid-nite, Boaz roll kon si sey woman sleep near am!
RUT 3:9 E kon ask, “Who yu bi?” Rut ansa, “Na yor savant Rut. Make yu marry mi yor savant, bikos yu bi senior man for awa family.”
RUT 3:10 Boaz ansa, “My pikin! Make God bless yu! Dis one wey yu do so, betta pass evritin wey yu don do before. Bikos yu nor even tink to marry any of di oda men, weda dem get money or not.
RUT 3:11 So Rut, make yu nor worry, I go do evritin wey yu ask for, bikos evribody for di village know sey yu bi good pesin.
RUT 3:12 True-true, I rilate to yor husband, but e get anoda relashon wey dey klose to Elimelek pass mi.
RUT 3:13 But make yu stay here dis nite. Wen day break, if e agri sey e go marry yu, den e good like dat. But if e nor gri, I promise sey as long as God dey alive, I go marry yu. So make yu sleep till day go break.”
RUT 3:14 So Rut sleep near am until morning rish. E wake-up wen day neva break well-well, bikos Boaz sey, “I nor wont make pipol know sey woman kom meet mi for here.”
RUT 3:15 Den e tell am, “Make yu spread yor skaf.” Rut kon do as e tok. So Boaz kon measure rice wey rish eight pounds put for di skaf and karry am put for Rut shoulder, so e kon karry am go house
RUT 3:16 go meet en moda-in-law. Wen Rut rish house, Naomi kon ask am, “My pikin, wetin happen?” Rut kon tell am all wetin di man do for am.
RUT 3:17 E kon sey, “E give mi dis rice wey rish eight pounds kon sey, ‘Make yu nor go back go meet yor moda-in-law with empty hand.’ ”
RUT 3:18 Den Naomi sey, “My pikin, make yu nor worry; wait until dem setol di matter. Di man nor go rest until e handle di matter today.”
RUT 4:1 Naw, Boaz kon go sidan for di village gate. Wen di relashon wey dey klose to Elimelek dey waka pass; di man wey e tell Rut about, Boaz kon tell am. “My friend, abeg kom sidan for here, bikos I wont tok with yu!” So, e kon sidan.
RUT 4:2 Boaz koll ten leaders for di village make dem kon sidan too. And dem kon sidan.
RUT 4:3 Den Boaz tell Elimelek relashon wey klose pass sey, “Naomi wey kom back from Moab won sell di land wey bi awa broda Elimelek, en husband own.
RUT 4:4 E good make yu know about am. So if yu wont am, make yu buy am for di leaders present wey sidan here. But if yu nor wont am, make yu tok, bikos na yu get rite to buy first, before mi.” Den di man sey, “I go buy am.”
RUT 4:5 Den Boaz still sey, “If yu buy Naomi farm, dat mean sey yu go buy Rut, en pikin wife, wey follow Naomi kom from Moab, so dat di land go still dey Elimelek family.”
RUT 4:6 Den di man ansa, “If na like dat, den make yu, Boaz, buy am, bikos I nor wont kause wahala for my family. Make yu buy am, I nor wont again.”
RUT 4:7 (As dem dey do before for Israel, wen dem won setol matter about land or propaty, na tradishon sey di pesin wey won sell go pul en sandal give di pesin wey won buy. Na like dis Israel pipol take dey show sey di matter don setol.)
RUT 4:8 So wen di man tell Boaz make e buy am, e kon pul en sandal give Boaz.
RUT 4:9 Den Boaz tell di leaders and evribody wey dey der, “All of una na witness sey, ‘Today I don buy from Naomi, evritin wey bilong to Elimelek and en shidren, Kilion and Mahlon.’
RUT 4:10 I don buy Rut, wey kom from Moab, Mahlon wife, as my wife, so dat di propaty go still dey Elimelek family and en name go still dey among en pipol and en house. All of una na witness today.”
RUT 4:11 Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.
RUT 4:12 Di shidren wey God go give yu thru dis woman go make yor family bi like Perez own. Perez wey bi Judah and Tamar pikin.”
RUT 4:13 So Boaz kon marry and sleep with Rut. God kon let Rut get belle and e kon born boy.
RUT 4:14 Di wimen for di village kon tell Naomi, “Make praiz bi God own, bikos E nor leave yu without who go take kare of yu! Dis pikin go popula for Israel!
RUT 4:15 E go enkourage and provide for yu wen yu don old, bikos yor pikin wife wey love yu, don born boy for yu. And wi know sey di woman betta pass seven boys to yu!”
RUT 4:16 Naomi put di pikin for en lap kon kare for am.
RUT 4:17 Di wimen for di village kon sey, “Naomi don get boy pikin.” So dem koll am Obed. Na Obed bi Jesse papa and na dis Jesse born David!
RUT 4:18 Na Perez family bi dis: Perez na Hezron papa
RUT 4:19 and Hezron born Ram. Ram born Amminadab
RUT 4:20 and na Amminadab born Nahshon. Nahshon na Salmon papa
RUT 4:21 and Salmon born Boaz wey bi Oded papa.
RUT 4:22 Na Oded bi Jesse papa and na Jesse born David.
1SA 1:1 E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.
1SA 1:2 Elkanah get two wife; di first one name na Hannah, while di sekond one na Peninnah. Peninnah get shidren, but Hannah nor get.
1SA 1:3 Evry year, Elkanah dey from en town go woship and sakrifice to God for Shiloh. Na der, Eli two pikin (Hofni and Finehas) dey for serve God as priest.
1SA 1:4 Wen ever e rish Elkanah turn to woship God, e dey give meat to en wife Peninnah and all en shidren.
1SA 1:5 But e dey give Hannah doubol part, bikos e love am well-well, but God neva give Hannah pikin.
1SA 1:6 Peninnah dey always laf and make yanga for Hannah, bikos God neva give Hannah shidren.
1SA 1:7 Peninnah dey always bihave like dis evry years. Anytime wey Hannah go God house, Peninnah go laf and curse am, so Hannah go dey kry and e nor go gri chop.
1SA 1:8 One day, Elkanah kon ask Hannah, “Wetin make yu dey kry and nor gri chop? Why yu dey vex? I nor dey good for yu pass ten boy pikin?”
1SA 1:9 So one day wen dem go Shiloh, afta dem don chop and drink finish, Hannah stand up kon go pray. (Dat time Eli wey bi priest sidan for en chair wey dey God Temple door-mot.)
1SA 1:10 Hannah nor dey happy as e dey pray give God, so e kon dey kry.
1SA 1:11 So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”
1SA 1:12 As Hannah still dey pray give God, Eli kon dey look en mout.
1SA 1:13 Naw, Hannah dey pray from en heart. Aldo en lips dey move, but dem nor dey hear en vois. So Eli kon feel sey Hannah don drink well-well.
1SA 1:14 So e tell am, “Why yu drink kom here? Make yu nor dey drink again!”
1SA 1:15 But Hannah ansa, “My oga! Nor bi as yu tink am! My mind nor setol at-all. I nor drink as yu dey tink o-o. I just dey tell God evritin wey dey my heart.
1SA 1:16 Nor tink sey yor savant dey wiked, bikos I just dey pray since bikos my heart dey heavy.”
1SA 1:17 Eli kon ansa, “Make yu go! Make peace follow yu and make Israel God give yu wetin yu wont.”
1SA 1:18 So, Hannah kon sey, “Make mi, yor savant get favor for yor eyes.” So di woman go find wetin e go chop and e kon dey happy.
1SA 1:19 Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.
1SA 1:20 Afta sometaim, Hannah get belle kon born boy. Den Hannah koll am, Samuel, bikos e sey, “I ask God make E gi-am to mi.”
1SA 1:21 Di next year, Elkanah and en family kon go sakrifice give God again and dem gi-am di vow wey dem make,
1SA 1:22 but Hannah nor go. Instead, e tell en husband, “Wen di boy don big small, I go bring am to God kon gi-am to am forever.”
1SA 1:23 So, Elkanah sey, “Make yu do wetin dey yor mind. Stay with di boy until e fit stay alone. Make God komplete wetin E don start.”
1SA 1:24 So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.
1SA 1:25 Afta dem don kill di melu, dem kon take di boy go give Eli.
1SA 1:26 Hannah kon sey, “Oga, yu remember mi so? Na mi bi di woman wey yu si stand for here dey pray give God.
1SA 1:27 I ask am for pikin and E don give mi wetin I wont.
1SA 1:28 Naw, I don gi-am to God. From today go, I dey dedikate am give God.” Den, dem kon woship God for der.
1SA 2:1 Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.
1SA 2:2 Nobody dey holy like God! E nor get anybody wey strong like Yu! E nor get any rock wey bi like God.
1SA 2:3 Make una stop to tok anyhow; make betta word dey kom out from una mout, bikos di Oga God na God wey know evritin wey pipol dey do.
1SA 2:4 Sojas swod don break to pieces, but doz wey dey weak, God dey make dem strong again.
1SA 2:5 Pipol wey dey chop well and get evritin before, don dey fine work naw, so dat dem go si food chop, while doz wey dey hongry before, don si plenty food chop. Even di woman wey neva get belle before, don born seven shidren, but di ones wey get plenty shidren, nor get again.
1SA 2:6 God dey kill and give life; E dey beri and raiz pipol from deat.
1SA 2:7 E dey make some poor kon make odas rish. E dey honbol some kon make odas great.
1SA 2:8 E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.
1SA 2:9 E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.
1SA 2:10 God go skata en enemies; E go skata dem with tonda from heaven. God dey judge di world from biginnin go rish di end. E go give en king pawa kon honor di one wey E anoint.”
1SA 2:11 Den, Elkanah and en family kon go back to Rama. But Samuel stay for Shiloh dey serve God with Eli wey bi di priest.
1SA 2:12 Eli sons dey wiked and dem nor dey do wetin God kommand.
1SA 2:13 Naw, na so di priest dey trit di pipol: Wen anybody dey make sakrifice, as di meat dey boil, di priest savant go kom with fork wey get three head.
1SA 2:14 Dem go put am inside di pot, basin or kettol and anytin wey di fork bring kom out, go bi di priest own. Dis na wetin dem dey do to all Israel pipol wen ever dem kom Shiloh.
1SA 2:15 Even before dem go burn di fat wey dey di meat, di priest savant go kom tell di pipol sey, “Make una give di priest some meat make e roast. E nor go take meat wey dem don boil from una, escept di one wey dem neva kook.”
1SA 2:16 If di pipol sey, “Make wi first boil di fat wey dey di meat, den yu fit take yor own komot,” di priest go sey, “No! Make una gi-am to mi like dat! If una nor give mi naw, I go use force take am!”
1SA 2:17 Eli shidren sin too plenty for God eye, bikos dem dey trit God ofrin anyhow without respet.
1SA 2:18 Naw, Samuel dey serve for God house. Di boy wear klean linen klot.
1SA 2:19 Anytime wey en mama kom with en husband to do sakrifice evry year, dem dey bring new dress for Samuel.
1SA 2:20 Eli go kon bless Elkanah and en wife sey, “Make God give yu many shidren thru dis woman and di shidren go replace Samuel wey yu dedikate give God.” Den dem go-go back to dia house.
1SA 2:21 So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.
1SA 2:22 Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.
1SA 2:23 E kon tell dem, “Why una dey bihave like dis? Bikos I don hear all di bad tins wey una dey do.
1SA 2:24 My shidren, e nor suppose bi like dis, bikos di tin wey I dey hear about una from God pipol, nor dey good to hear.
1SA 2:25 If man sin against man, pesin fit beg God to forgi-am. But if man sin against God, na who go kon pray for am?” But di boys nor gri listin to dia papa, bikos God don sey E go kill dem.
1SA 2:26 So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.
1SA 2:27 One man of God kom Eli house kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Wen Aaron and en family bi slave for Egypt, I show mysef to Aaron.
1SA 2:28 From all di tribes for Israel, I choose una grand-grand papa Aaron family to bi priest, so dat dem go serve and burn incense for mi, den kon wear di priest garment for my present. And I give dem di rite to take some from di sakrifice wey pipol dey burn give mi.
1SA 2:29 So wetin make dem get long-trot for di sakrifice and ofrin wey I sey make dem put for where I dey? Eli, yu don honor yor boys pass mi, bikos yu don make dem fat from di best part of meat from all di ofrin wey my pipol for Israel dey bring.’
1SA 2:30 “So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!
1SA 2:31 Make yu listin, di time dey kom wen I go kill all di yong men wey dey yor family and town, so dat no man for yor family go get long life.
1SA 2:32 Yu go si trobol for here wey I dey! Even doh I go bless Israel pipol, nobody for yor family go ever rish old age.
1SA 2:33 I go keep one man for yor family and e go serve mi as priest. But I go blind en eye; e nor go get hope and all yor shidren and shidren-shidren go die yeye deat.
1SA 2:34 “ ‘Wen yor two boys, Hofni and Finehas, go die for di same day, den yu go know sey evritin wey I tok, go happen.
1SA 2:35 Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.
1SA 2:36 Evribody wey remain for yor house go kom bow for en front dey ask for money and food and dem go dey beg to help di priests, so dat dem go get food to chop.’ ”
1SA 3:1 Samuel kontinue to serve God under Eli di priest and for dat time, God nor dey too give dem message or vishon.
1SA 3:2 One nite, Eli wey nor dey si well-well again dey sleep for en room
1SA 3:3 and Samuel dey sleep for where di Kovenant Box dey. Before day break as di lamp still dey on
1SA 3:4 God kon koll Samuel and e ansa, “Na mi bi dis!”
1SA 3:5 Den e run go meet Eli kon sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” But Eli sey, “I nor koll yu. Make yu go back go sleep.”
1SA 3:6 Den God koll again, “Samuel!” So Samuel get up kon go meet Eli sey, “Si mi here, yu dey koll mi.” But Eli ansa, “I nor koll yu my pikin. Make yu go back go sleep.”
1SA 3:7 Naw Samuel neva still know God; e neva know wen God dey tok.
1SA 3:8 Den God koll Samuel for di third time. E get up go meet Eli sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” Eli kon know sey na God dey koll di boy.
1SA 3:9 So e kon tell Samuel, “Go back go sleep. Wen yu hear di vois koll yu again, make yu sey, ‘Oga, tok to mi, yor savant dey listin.’ ” So Samuel kon go back go sleep.
1SA 3:10 Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!” So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”
1SA 3:11 God tell Samuel, “Look! I won do sometin for Israel; wen anybody hear am, en two ear go dey shine like star.
1SA 3:12 For dat day, I go ponish Eli family as I don tell am before and evritin wey I tok from biginnin go rish end, go happen!
1SA 3:13 Make yu tell am sey, I won judge en family forever, bikos of di sins wey en ensef know about. Bikos en boys shidren dey curse God and e nor stop dem.
1SA 3:14 So, I don swear for Eli house sey, ‘Dem nor go fit use sakrifice or korn ofrin take forgive di sin wey Eli family kommit.’ ”
1SA 3:15 So Samuel sleep until day break. Den e open di door for God house. But Samuel dey fear to tell Eli di vishon.
1SA 3:16 Eli koll Samuel kon sey, “Samuel my pikin!” Samuel ansa, “Si mi here.”
1SA 3:17 Eli ask am, “Na wetin God tell yu? Nor hide am from mi, if not God go ponish yu well-well!”
1SA 3:18 So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”
1SA 3:19 Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.
1SA 3:20 Evribody for Israel from Dan go rish Beersheba know sey Samuel na real profet from God.
1SA 3:21 God kon dey show ensef for Shiloh, di place wey e for appear to Samuel kon tok to am. And wen Samuel tok, evribody for Israel dey listin to am.
1SA 4:1 Den Samuel tell Israel pipol wetin God tok. Israel pipol kon go fight Filistia pipol. Dem kamp for Ebeneza and Filistia pipol kamp for Afek.
1SA 4:2 Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. Wen di fight start, Filistia pipol kon win and kill about 4,000 Israel men for di war.
1SA 4:3 Wen di sojas kom back to dia kamp, Israel leaders kon sey, “Wetin make God let Filistia pipol win us like dis? Make wi karry God Kovenant Box from Shiloh, follow body. If di box dey with us, e go save us from awa enemies.”
1SA 4:4 So dem send some sojas go Shiloh go karry God Kovenant Box wey dey for di cherubim centre. Eli two boys pikin, Hofni and Finehas, dey der with God Kovenant Box.
1SA 4:5 Wen God Kovenant Box rish di kamp, Israel pipol kon shaut well-well, sotey di groun kon dey shake.
1SA 4:6 Wen Filistia pipol hear di pipol shaut, dem kon sey, “Wetin make Israel pipol dey shaut like dis for Hibru kamp?”
1SA 4:7 Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o!
1SA 4:8 Dis one sirious well-well! Na who go save us from dis big-big gods? Dis na di gods wey kill Egypt pipol with difren diziz for di desert!
1SA 4:9 So Filistia pipol, make una dey strong kon bihave like men, if not una go serve Hibru pipol di way wey dem don serve una! Make una fight dem like men!”
1SA 4:10 So Filistia pipol kon fight and kill Israel pipol well-well till di remainin ones, run go house. Di pipol wey dem kill many well-well; 3,000 sojas wey dey waka for groun die for di war;
1SA 4:11 dem take di Kovenant Box go and Eli two boys, Hofni and Finehas die too.
1SA 4:12 Dat day, one man from Benjamin tribe run from di war front go Shiloh. E shirt don tear and dirty full en head.
1SA 4:13 Wen e rish Shiloh, Eli sidan for chair for outside dey look di road, bikos en mind dey disturb am about di Kovenant Box. As di man enter di town go tok wetin happen, di whole town kon dey kry.
1SA 4:14 Wen Eli hear dem dey kry, e kon sey, “Wetin dey happen?” Di man run go meet Eli kwik-kwik.
1SA 4:15 Dis time, Eli na ninty-eight years. En eyes open, but e nor dey fit si well.
1SA 4:16 Di man kon tell Eli, “I run komot from di war front today!” Eli kon ask am, “My pikin, na wetin dey happen for dat side!”
1SA 4:17 Di man ansa, “Israel pipol don run from Filistia pipol! Dem don kill di sojas well-well! Yor two boys, Hofni and Finehas, don die too. And dem don karry God Kovenant Box go!”
1SA 4:18 As di man koll God Kovenant Box, Eli kon fall from en chair go back near di gate. En neck break and e kon die, but e don old well-well. E judge Israel pipol for forty years.
1SA 4:19 En pikin, Finehas wife get belle and don nearly born. Wen e hear sey Filistia pipol don take di Kovenant Box and en husband and en husband papa don die, e shaut well-well kon born. But di pains too mush for am.
1SA 4:20 As e dey die, di wimen wey dey with am kon sey, “Nor fear! Yu don born boy!” But e nor ansa dem or listin to wetin dem dey tok.
1SA 4:21 E koll di pikin Ikabod, wey mean “God glory don komot from Israel,” e dey tok about di Kovenant Box wey Filistia pipol don karry go, en husband and husband papa wey don die.
1SA 4:22 E kon sey, “God glory don komot from Israel, bikos Filistia pipol don karry God Kovenant Box go.”
1SA 5:1 Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod.
1SA 5:2 Dem take di Kovenant Box go Dagon temple kon put am near Dagon.
1SA 5:3 Wen di pipol for Ashdod wake-up di next day, Dagon don fall for groun for di box front. So dem take Dagon kon put am back for where e suppose dey.
1SA 5:4 But wen dem wake-up di next day again, Dagon dey groun for di Kovenant Box front. Dis time, en head and hand don break komot and e liedan face di door. Na only di body remain.
1SA 5:5 Bikos of dis, go rish today, nobody fit enter Dagon temple again, bikos anybody wey won enter di temple for Ashdod, go first mash Dagon head pass.
1SA 5:6 God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.
1SA 5:7 Wen Ashdod pipol si wetin dey happen, dem kon sey, “Make dem komot Israel God Kovenant Box from here, bikos e don attack both wi and Dagon wey bi awa god!”
1SA 5:8 So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?” Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.
1SA 5:9 But afta dem don komot am, God attack di town again kon make all of dem dey fear. E make sore full di pipol body.
1SA 5:10 So dem karry di box go Ekron, den di pipol for Ekron kon shaut dey sey, “Dem don bring Israel God Kovenant Box kom here, so dat e go kill awa pipol!”
1SA 5:11 So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well.
1SA 5:12 Doz wey nor die, get sore full body and di kry wey di town pipol dey kry, dey even rish heaven.
1SA 6:1 Di Kovenant Box dey for Filistia pipol land for seven monts.
1SA 6:2 So Filistia pipol koll di priest and doz wey dey si vishon kon sey, “Wetin wi go do with di Kovenant Box? Make una tell us how wi go take karry am go back to where e suppose dey.”
1SA 6:3 Dem kon ansa, “If una won riton Israel God box go back to where e dey before, una must karry sometin join am. Una must put ofrin wey go show sey wetin una do nor good. Den una go dey well and una go know wetin make God dey ponish una.”
1SA 6:4 Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.
1SA 6:5 Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.
1SA 6:6 Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?
1SA 6:7 “So make una go make truck, plus two melu wey dem neva put wood cross dia head before. Make una karry dem for di truck kon drive dem with dia pikin go di yard.
1SA 6:8 Den make una take di Kovenant Box put for di truck kon add di gold tins wey una won give God join am, as ofrin for wetin una don do so. Den una go send am go.
1SA 6:9 But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”
1SA 6:10 So di men go do as di priest tell dem. Dem take two melu kon join dem to di truck; dem put dia pikin from di yard.
1SA 6:11 Dem kon put di Kovenant Box for der, plus di cupboard, di gold rat and sore image.
1SA 6:12 Den di melu kon go strait to Bet-Shemesh. Dem dey make nois as dem dey go. Dem nor turn face left or rite. Filistia pipol leaders follow dem for back until dem rish Bet-Shemesh borda.
1SA 6:13 By dis time, di pipol for Bet-Shemesh dey harvest wetin dem plant for dia farm. Wen dem look up kon si di box, dem happy well-well.
1SA 6:14 Di truck enter one field for Bet-Shemesh and na Joshua own, den e stop for der near one big stone. Di pipol skata di truck, kill and offa di two melu as burnt ofrin give God.
1SA 6:15 Doz wey kom from Levi tribe, karry di Kovenant Box with di cupboard wey get di gold tins wey follow di box kon go put am near di big stone. So Bet-Shemesh pipol offa burnt ofrin and sakrifice to God.
1SA 6:16 Di five Filistia pipol leaders dey wosh wetin dey happen, but dem go back to Ekron for dat same day.
1SA 6:17 Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.
1SA 6:18 Dem still bring gold rat for each towns wey di five kings dey rule; from di strong ones go rish di village dem, plus di Great Abel where dem put di Kovenant Box, until di day wey e rish Joshua (wey kom from Bet-Shemesh), field.
1SA 6:19 But God kill some of Bet-Shemesh pipol, bikos dem go look inside di box; pipol wey God kill na 50,070. Di pipol kry, bikos God kill dia pipol.
1SA 6:20 Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”
1SA 6:21 So dem kon send messenja go meet di pipol wey dey Kiriat-Jearim sey, “Filistia pipol don riton di Kovenant Box. Make una kom take am go house.”
1SA 7:1 Den, Kiriat-Jearim pipol kom karry di Kovenant Box go Abinadab house wey dey di hill. Dem kon santify Abinadab pikin, Eleazar, so dat e go dey guide di box.
1SA 7:2 So di Kovenant Box stay for Kiriat-Jearim for twenty years. For dis time, Israel pipol dey kry give God make E help dem.
1SA 7:3 Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”
1SA 7:4 So di pipol remove all Ashtoret gods and juju and dem kon dey serve only God.
1SA 7:5 Den Samuel sey, “Make una gada evribody for Israel kom Mizpa and I go pray to God for una.”
1SA 7:6 Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.
1SA 7:7 Wen Filistia pipol hear sey Israel pipol don gada for Mizpa, dia leaders kon gada dia sojas make dem for go fight Israel pipol. As Israel pipol hear sey Filistia pipol dey kom, fear kon katch dem.
1SA 7:8 So dem kon tell Samuel, “Abeg! Make yu still pray to di Oga awa God, so dat E go save us from Filistia pipol!”
1SA 7:9 So Samuel take one small sheep kon offa am as one full ofrin to God. Samuel pray to God for Israel pipol and God kon ansa am.
1SA 7:10 As Samuel dey burn di ofrin, Filistia pipol dey kom fight Israel pipol. But for dat day, God kon send tonda from heaven go meet Filistia pipol. E make dem fear well-well and Israel pipol kon kill dem well-well.
1SA 7:11 Den, Israel men kon from Mizpa porshu Filistia pipol kon kill dem rish one aria for Bet-Car.
1SA 7:12 Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”
1SA 7:13 So Israel pipol win Filistia pipol and dem nor fight Israel pipol again. Thru-out Samuel time, God dey against Filistia pipol.
1SA 7:14 All di towns wey Filistia pipol don take from Israel before, Israel pipol kon take dem back from Ekron go rish Gat. Israel pipol take dia aria from Filistia pipol hand and peace kon dey between Israel and Amor pipol.
1SA 7:15 So Samuel lead Israel pipol till e die.
1SA 7:16 Evry year, e dey travel go Bethel and from der, e go-go Gilgal till e rish Mizpa kon dey judge Israel pipol for evriwhere.
1SA 7:17 Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.
1SA 8:1 Wen Samuel don old, e kon sey make en sons dey judge Israel pipol.
1SA 8:2 En first boy name na Joel and di sekond one na Abijah. Dem dey judge Israel pipol for Beersheba.
1SA 8:3 But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well.
1SA 8:4 So all di leaders for Israel gada go meet Samuel for Rama
1SA 8:5 kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”
1SA 8:6 But Samuel nor like wetin dem ask for, bikos dem sey, “Give us king wey go lead us.” So Samuel kon pray to God.
1SA 8:7 God tell Samuel, “Make yu do evritin wey di pipol ask yu, bikos nor bi yu dem rijet, but na mi dem rijet as dia king.
1SA 8:8 Since I take dem komot Egypt kon rish today, na so dem dey rijet mi. Dem rijet mi kon dey serve difren gods. Na di same tin dem dey do to yu naw.
1SA 8:9 So naw, make yu do as I tok. But make yu warn dem well-well kon make dem know evritin about how di king go rule dem.”
1SA 8:10 So Samuel tell di pipol wey dey ask for king evritin wey God don tok.
1SA 8:11 E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.
1SA 8:12 “Na only en go choose leaders wey go dey look ova tazon and doz wey go dey look ova fifty, plus doz wey go dey klear en field kon harvest wetin e plant and dem go dey make en war materials for am.
1SA 8:13 Una dotas go make pomade, kook and bake for di king.
1SA 8:14 E go take una best field and vineyard kon give dem to en own savants.
1SA 8:15 One part out of evry ten seed and food wey una harvest, e go kollect am go give en ofisas and savants.
1SA 8:16 Una man and woman savant, plus una best animals, di king go take and use dem for ensef.
1SA 8:17 E go take one out of evry ten animals wey una get and unasef go bi en savants.
1SA 8:18 For dat day, una go kry, bikos of una king wey una take una hand choose, but God nor go ansa una.”
1SA 8:19 But di pipol still sey dem wont king. Dem nor gri listin to di warnin wey Samuel dey give dem.
1SA 8:20 Dem dey sey, “Wi won bi like oda nashons. Awa king go judge and lead us and e go fight awa fight.”
1SA 8:21 So Samuel listin to all wetin di pipol dey tok kon go tell God.
1SA 8:22 God tell Samuel, “Go do as dem tok and make yu give dem king wey go rule dem.” Den Samuel tell di men for Israel, “Make all of una dey go back to una house.”
1SA 9:1 E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere.
1SA 9:2 E get one pikin, en name na Saul and e fine well-well. E nor get anybody for Israel wey fine rish am and e tall pass evribody for Israel.
1SA 9:3 One day, Saul papa donkey kon waka lost, so Kish kon tell Saul, “Make yu take one savant follow body, den make una go find di donkey.”
1SA 9:4 So Saul cross Efraim hill kountries kon pass thru Shalisha land, but dem nor si di donkey.
1SA 9:5 Wen dem rish Zuf land, Saul kon tell en savant wey dey with am sey, “Make wi dey go back before my papa go stop to worry for di donkey kon dey worry for us.”
1SA 9:6 But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”
1SA 9:7 So Saul ansa, “Okay! Make wi go der. But wetin wi go give di man since wi don finish all di food for awa bag? Wi nor get any gift wey wi go give God savant.” Den e ask en savant, “Na wetin wi still get?”
1SA 9:8 Di savant ansa, “Si, I still get small money for my hand. Wi go gi-am to God savant and e go tell us wetin wi go do.”
1SA 9:9 (For dat time for Israel, if anybody won go hear from God, e go sey, “Kom make wi go si di pesin wey dey si vishon.” Bikos dat time, dem dey koll profet, “Pesin wey dey si vishon.”)
1SA 9:10 Saul tell en savant, “Yu wise well-well! Kom make wi dey go.” So dem kon go di town where God savant dey.
1SA 9:11 As dem dey waka enter di town, dem kon meet some girls wey go draw wota dey kom. So dem ask dem, “Di man wey dey si vishon, na here e dey stay?”
1SA 9:12 Di girls ansa, “Yes! Make una still waka go strait. But una go waka fast, bikos na today e kom di town and di pipol dey do sakrifice for di altar wey dey di hill.
1SA 9:13 And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”
1SA 9:14 So dem kon waka enter di town. As dem dey waka go di town centre, Samuel dey waka kom dia way and e dey go di altar for di hill.
1SA 9:15 Naw, di day before Saul kom, God don tell Samuel:
1SA 9:16 “For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”
1SA 9:17 Wen Samuel si Saul, God kon tell am, “Na di man wey I tell yu bi dis. E go rule my pipol.”
1SA 9:18 As Saul dey waka near Samuel for di gate centre, e kon ask Samuel, “Abeg tell mi where di man wey dey si vishon dey stay.”
1SA 9:19 Samuel ansa Saul, “Na mi dey si tumoro. Waka for my front go di altar for hill. Today yu go follow mi chop, den yu go-go house tumoro. I go tell yu evritin wey yu dey tink.
1SA 9:20 Make yu nor worry about di donkey dem wey lost three days ago, bikos dem don si dem. But na who Israel pipol dey look for? Na yu and evribody for yor papa house?”
1SA 9:21 Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”
1SA 9:22 Den Samuel take Saul and en savant enter room kon show dem where dem go sleep. Di place betta pass di ones wey dem give doz wey dem invite. Na like thirty men kom di sakrifice.
1SA 9:23 Samuel kon tell di pesin wey dey kook sey, “Give mi di food wey I sey make yu keep for mi.”
1SA 9:24 So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.
1SA 9:25 Before dem kom down from di altar for di hill kon enter di town, Samuel follow Saul tok on-top di house.
1SA 9:26 As dem wake-up for morning, Samuel koll Saul on-top di house kon sey, “Make yu get up dey go house.” So Saul get up and di two of dem kon go outside.
1SA 9:27 As dem dey waka kom di town, Samuel kon tell Saul, “Tell yor savant make e waka dey go for front.” So Saul kon tell en savant. Den Samuel sey, “Yu go stay here small, so dat I go-go do wetin God sey make I do.”
1SA 10:1 Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.
1SA 10:2 Wen yu leave mi today, yu go si two men near Rashel Grave for Benjamin borda wey dey Zelzah. Dem go tell yu, ‘Di donkey dem wey yu dey fine, dem don si dem. Yor papa nor dey worry for di donkey again, but e dey worry for una too. E dey ask sey, “Wetin I go do naw wey I nor si my pikin?” ’
1SA 10:3 “As yu dey go from here, yu go rish dat tall tree for Tabor. Dat time, three men wey dey go meet God for Bethel, go meet yu. One of dem go karry three bread and one go karry one kontaina wey get wine.
1SA 10:4 Dem go ask yu how yu dey and dem go give yu two bread. Make yu kollect dem.
1SA 10:5 “Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.
1SA 10:6 Den God Spirit go enter yu and yu go dey profesai as dem dey do. Yu go bi like anoda pesin.
1SA 10:7 Wen dis signs don happen, make yu do anytin wey yu fit do, bikos God go dey with yu.
1SA 10:8 “Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”
1SA 10:9 As Saul turn leave Samuel dey go, God kon shange as Saul dey tink. All di signs happen for dat same day.
1SA 10:10 Wen dem rish Gibeah, some profets kom meet am. Den God Spirit enter Saul body and e kon bigin tok like di profets.
1SA 10:11 Wen evribody wey know am before si am dey tok like profet, dem kon dey ask each oda, “Wetin dey happen to Kish pikin? Saul sef don bi profet?”
1SA 10:12 One man wey kom from der kon ansa, “Na who bi dia papa?” So dis tin kon turn parabol: “Saul sef dey among di profets?”
1SA 10:13 Wen Saul don tok finish, e kon go di altar for di hill.
1SA 10:14 Saul papa broda kon ask en and en savant, “Na where una go?” Saul ansa, “Wi go look for di donkey. But wen wi nor si dem, wi kon go meet Samuel.”
1SA 10:15 Saul papa broda kon sey, “Make yu tell mi wetin Samuel tell yu.”
1SA 10:16 Saul ansa am, “E tell us sey dem don si di donkey.” But Saul nor tell am wetin Samuel tell am about to bi Israel pipol king.
1SA 10:17 Den Samuel koll di pipol make dem kom meet God for Mizpa.
1SA 10:18 E tell dem, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I bring una kom out from Egypt kon diliver una from dia pawa and from all di kingdoms wey dey opress una.
1SA 10:19 But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”
1SA 10:20 Den Samuel bring all di tribe for Israel and dem kon trow dice take choose Benjamin tribe.
1SA 10:21 Den e bring Benjamin tribe akordin to family and na Matri family dem choose. At last, dem kon choose Kish pikin wey en name na Saul wen dem trow di dice. But wen dem look for am, dem nor si am.
1SA 10:22 So dem kon ask God again sey, “Di man don rish here?” God ansa, “E hide ensef for back of di tins wey dem dey supply.”
1SA 10:23 So dem run go karry am kom from der. Wen e stand with di pipol, e tall pass all of dem.
1SA 10:24 Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”
1SA 10:25 Samuel tell di pipol how di king go work. E rite evritin down for book kon put am for God present. Den Samuel sey make evribody dey go dia house.
1SA 10:26 Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah.
1SA 10:27 But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.
1SA 11:1 Nahash dem wey bi Ammon pipol kon mash dey go fight Jabesh pipol. All di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Make wi make peace with una and wi go serve una.”
1SA 11:2 But Nahash pipol wey bi Ammon pipol kon ansa, “Di only way wey wi fit make peace with una, na if una agri make wi blind evribody rite eye and dis go bi disgrace for Israel pipol!”
1SA 11:3 Di leaders for Jabesh kon tell dem, “Make una give us seven days, so dat wi go send message go evriwhere for Israel. If nobody dey to diliver us, den wi go do as una wont.”
1SA 11:4 Wen di pesin wey dem send rish Gibeah (where Saul dey stay) kon tell dem wetin dey happen, all di pipol kon bigin kry.
1SA 11:5 Naw, Saul just dey bring en animals kom back from farm. Wen Saul si di pipol, e kon ask, “Wetin happen? Wetin make una dey kry?” Dem kon tell am about di men for Jabesh.
1SA 11:6 As Saul hear dis word, God Spirit enter en body and e kon dey vex.
1SA 11:7 Saul kut two melu to many parts kon tell some pipol make dem karry di parts go evriwhere for Israel sey, “Anybody wey nor gri follow Saul and Samuel, make e know sey na so dem go do en melu!” Den God make fear enter di pipol and dem kon go fight as one family.
1SA 11:8 Wen Saul kount all of dem for Bezek, Israel pipol na 300,000 strong men, while Judah men, na 30,000.
1SA 11:9 Dem kon tell di pesin wey dem send kom, “Dis na wetin yu go tell Jabesh: ‘Tumoro, una go dey save wen di sun don dey shine well-well.’ ” Wen di messenja go tell Gilead pipol di message, belle sweet dem well-well.
1SA 11:10 Di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Tumoro, wi go kom surenda to una and make una trit us as una like.”
1SA 11:11 Di next day, Saul kon divide di pipol into three group. Dem go Ammon pipol kamp for morning kon kill all of dem until aftanoon. And di pipol wey remain, run skata go difren place.
1SA 11:12 Den di pipol kon tell Samuel, “Na who bi di pipol wey dey ask sey, ‘So Saul go kon rule us?’ Tell us who dem bi, so dat wi go kill all of dem!”
1SA 11:13 But Saul ansa, “Una nor go kill anybody today. Bikos God don make Israel pipol win!”
1SA 11:14 Samuel tell di pipol, “Make una kom make wi go Gilgal go crown Saul.”
1SA 11:15 So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.
1SA 12:1 Samuel tell Israel pipol, “I don do evritin where una ask for. I don give una king.
1SA 12:2 Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today.
1SA 12:3 Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”
1SA 12:4 Di pipol ansa, “Yu neva do us wrong or opress us. Yu neva take anytin from anybody hand.”
1SA 12:5 Samuel kon tell dem, “God and di king wey E choose na witness sey una neva akuiz mi for any bad tin.” Di pipol ansa, “Yes! Dem bi witness!”
1SA 12:6 Samuel tell di pipol, “Na God choose Moses and Aaron and na en take una grand-grand papa komot from Egypt.
1SA 12:7 Naw, make una stand for God present, so dat I go remind una about all di good-good tins wey God don do for una and una grand-grand papa.
1SA 12:8 “Wen Jakob enter Egypt, una grand-grand papa dem kon kry to God. God send Moses and Aaron and dem lead dem komot from Egypt kon stay for here.
1SA 12:9 “But dem forget di Oga wey bi dia God, so E give dem to Sisera wey bi oga for Hazor sojas, den to Filistia pipol; Moab pipol king and dem kon fight and opress Israel pipol.
1SA 12:10 Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’
1SA 12:11 So, God send Jerub-Baal, Barak, Jeftah and Samuel and E kon save una from una enemies.
1SA 12:12 “Wen una si sey King Nahash for Ammon dey kom fight una, una sey, ‘No! Wi wont king’, even doh na di Oga una God bi una king!
1SA 12:13 Naw make una look! Na di king wey una choose bi dis; di king wey una ask for. Si, God don give una king.
1SA 12:14 If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una.
1SA 12:15 But if una nor obey God kon go against wetin E tok, God hand go dey against both una and una king.
1SA 12:16 “So, make una stand for where una dey kon wosh di great tins wey God go do and una go si am with una eye.
1SA 12:17 Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”
1SA 12:18 So Samuel koll God and God kon make tonda and rain fall thru-out dat day. All di pipol kon dey fear God and Samuel.
1SA 12:19 Dem kon tell Samuel, “Make yu help us pray to God, so dat all of us nor go die, bikos wi don add join awa sins, wen wi ask for king.”
1SA 12:20 Den Samuel tell di pipol, “Make una nor fear. True-true, una don sin. But make una nor turn from God. Make una serve God with all una heart.
1SA 12:21 Make una nor bigin follow tins wey nor mean anytin, tins wey una nor go gain from or tins wey nor fit save una.
1SA 12:22 God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.
1SA 12:23 As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.
1SA 12:24 Make una dey fear and serve God with all una heart. Make una si all di wonderful tins wey E don do for una!
1SA 12:25 But if una kontinue to dey do bad tins, God go distroy both una and una king.”
1SA 13:1 Saul na thirty years wen e start to rule; e rule for more dan forty years.
1SA 13:2 Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.
1SA 13:3 Leta, Jonatan kill Filistia sojas for Gibeah and all Filistia pipol kon hear about am. Den Saul blow trumpet take koll all di Hibru pipol make dem kom fight.
1SA 13:4 Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.
1SA 13:5 Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.
1SA 13:6 Dem attack Israel pipol well-well and Israel sojas kon run go hide for di kaves, holes, inside rocks, pits and wells;
1SA 13:7 some run cross Jordan River kon enter Gad and Gilead aria. Saul still dey Gilgal and di pipol wey dey with am, don dey fear.
1SA 13:8 E wait Samuel for der for seven day, just as Samuel don tell am, but Samuel neva still kom Gilgal. So di sojas kon dey run leave Saul.
1SA 13:9 So Saul sey, “Make una karry di burn ofrin and di peace ofrin kom.” Den e kon do burnt ofrin.
1SA 13:10 Wen e don do di ofrin finish, Samuel kon kom. Saul kon go outside go greet am.
1SA 13:11 But Samuel sey, “Wetin yu don do so?” Saul ansa, “Wen I si sey di sojas don dey run leave mi and yu neva kom for di time wey yu suppose kom and I hear sey Filistia pipol don gada for Mikmash,
1SA 13:12 I kon sey, ‘Filistia pipol go kom meet mi for Gilgal and I neva ask God make E favor us.’ So I kon do di ofrin.”
1SA 13:13 Den Samuel tell Saul, “Na foolish tin yu don do so o-o! Yu nor obey di kommandment wey di Oga yor God give yu. If to sey yu obey, God for make yu king for Israel forever.
1SA 13:14 But naw, yor kingdom go end. Bikos yu nor obey am; God go fine di kind pesin wey E wont kon make am king wey go rule en pipol.”
1SA 13:15 Den Samuel go Gilgal and from der to Gibeah for Benjamin. Saul shek di sojas wey still dey with am and dem bi like six hundred.
1SA 13:16 So Saul, en pikin Jonatan and di sojas wey dey with am kon kamp for Gibeah for Benjamin, while Filistia pipol kamp for Mikmash.
1SA 13:17 Filistia sojas divide dia kamp into three group. One group face di road wey dem dey pass go Ofrah for Shual land;
1SA 13:18 anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.
1SA 13:19 E nor get anybody wey fit do iron work for Israel, bikos Filistia pipol nor wont make Israel pipol dey make swods and spears.
1SA 13:20 So wen Israel pipol wont sharpen or do any knife, den must go do am for Filistia pipol land.
1SA 13:21 Di money wey dem dey pay na one koin to sharpen axe and ripair shepad stik, den two koin to sharpen big and small hoes.
1SA 13:22 So wen di war start, na only Saul and en pikin get swod and spear, no oda soja for Israel karry swod or spear.
1SA 13:23 Filistia pipol kon send some sojas make dem go block Mikmash road.
1SA 14:1 One day, Saul pikin, Jonatan kon tell en savant wey dey karry en tins, “Make wi go Filistia sojas kamp wey dey di oda side.” But e nor let en papa know.
1SA 14:2 Saul sidan for outside for Gibeah under one tree wey en fruit bi like gold for Migron. Di sojas wey dey with am na about six hundred.
1SA 14:3 (Di priest wey wear di priest garment na Ahijah wey bi Ahitub broda Ikabod pikin and na Finehas wey Eli di priest for Shiloh born, na-im bi Ahitub papa.) Di men nor know sey Jonatan don leave dem.
1SA 14:4 For Mikmash road wey Jonatan must pass before e rish Filistia sojas kamp, two big rock dey der for each side: dem dey koll one Bozez and di oda one na Seneh.
1SA 14:5 Di rock wey face nort dey near Mikmash and di oda one wey dey sout dey near Gibeah.
1SA 14:6 Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
1SA 14:7 Di savant ansa, “Make yu do evritin wey dey yor mind. Do as yor mind dey tell yu. I dey with yu go rish di end.”
1SA 14:8 Jonatan kon sey, “Okay! Wi go-go fight doz men.
1SA 14:9 If dem sey, ‘Make una wait, wi dey kom meet una’, wi go stay for der until dem kom.
1SA 14:10 But if dem sey, ‘Make una kom’, wi go-go meet dem. Bikos like dat, wi go know sey God go help us and na dis go bi di sign to us.”
1SA 14:11 Wen Jonatan and en savant kon let Filistia sojas know sey dem dey around, Filistia pipol kon sey, “Si! Hibru pipol dey kom out from di hole wey dem hide put.”
1SA 14:12 Den Filistia sojas wey dey for Mikmash road kon tell Jonatan and en savant, “Make una kom meet us, so dat wi go show una pepper!” Den Jonatan kon tell en savant, “Make yu follow mi for back, bikos God don give dis men to Israel!”
1SA 14:13 Jonatan and en savant kon waka go with dia belle for groun. E attack all Filistia sojas for der and en and en savant kon kill dem.
1SA 14:14 For di first fight, Jonatan and en savant kill about twenty men and di aria big rish half-akar land.
1SA 14:15 Den fear kon katch di remainin Filistia sojas wey dey di kamp, field and evriwhere. Dem fear and di eart kon dey shake. Na God kause dis fear.
1SA 14:16 Saul men wey dey wosh for Gibeah for Benjamin kon si as all Filistia sojas dey run anyhow.
1SA 14:17 So Saul kon tell di soja wey dey with am, “Gada evribody make wi si who nor dey here with us.” Wen dem gada di sojas, Jonatan and en savant nor dey der.
1SA 14:18 So Saul tell Profet Ahijah, “Go bring di efod kom here.” (Bikos for dat day, Ahijah karry am for di sojas front.)
1SA 14:19 As Saul dey tok to di priest, di fear for Filistia pipol kamp dey strong more-more. So Saul kon tell di priest, “Time nor dey to ask God!”
1SA 14:20 Den en and en men kon mash dey go fight Filistia pipol wey don dey fear and kill each oda with swod.
1SA 14:21 Hibru pipol wey don first go fight Filistia pipol before, kom out kon join Israel pipol wey dey with Saul and Jonatan.
1SA 14:22 Wen all Israel pipol wey dey hide for Efraim kountry for hill hear sey Filistia pipol dey run, demsef kon kom out bigin porshu dem.
1SA 14:23 So God kon save Israel pipol dat day and di fight kontinue go rish Bet-Aven.
1SA 14:24 Naw, di men for Israel don dey hongry, bikos Saul make dem swear sey: “E nor go betta for any man wey go chop food before evening! Make nobody chop anytin until I don revensh my enemies!” So nobody chop anytin
1SA 14:25 even doh sey dem si honey full groun wen dem enter di forest.
1SA 14:26 Di honey dey rush like wota, but nobody try to chop from am, bikos dem dey fear di swear wey dem make.
1SA 14:27 But Jonatan nor hear about di swear wey en papa and di sojas swear. E kon take di rod wey dey en hand take pak di honey. Wen e chop am, en body kon fresh.
1SA 14:28 Den one soja kon tell am, “Yor papa make all di sojas dem swear sey, ‘E nor go betta for any man wey go chop food today!’ Dis na why di sojas dem don taya.”
1SA 14:29 Den Jonatan ansa, “My papa don kause wahala for di land. Si as my body just fresh wen I taste only small for di honey.
1SA 14:30 True-true, if to sey di sojas chop some for Filistia pipol food, yu nor know sey wi for fit kill dem well-well?”
1SA 14:31 Dat day Israel sojas kill Filistia pipol from Mikmash go rish Aijalon and dem kon taya.
1SA 14:32 So di sojas kon rush with honga, bigin kill both sheep, kattle and melu. Dem kill dem kon chop di animal, di blood and evritin.
1SA 14:33 So dem kon tell Saul wetin dey happen, “Si, di sojas don sin against God as dem dey chop evritin plus blood sef.” Saul kon sey, “All of una don break di kovenant! So make una roll one big stone kom here.”
1SA 14:34 Den e kon kommand: “Make una go tell di pipol make all of dem bring dia animals kom here. Dem go kill-am chop for my front; but make dem nor chop di blood, so dat God nor go vex for dem.” So for dat nite, all of dem kon bring dia animal kill and chop for der.
1SA 14:35 Den Saul build one altar for God and dis na di first time wen e dey build altar for God.
1SA 14:36 Saul kon sey, “Make wi go porshu Filistia pipol for nite; wi go kill dem until day go break and make wi nor sorry for anybody.” Di sojas ansa, “Make yu do wetin yu like.” But di priest kon sey, “Make wi ask God first for here.”
1SA 14:37 So Saul ask God, “Make wi porshu Filistia pipol? Yu go give dem to us?” But God nor ansa am dat day.
1SA 14:38 Den Saul sey, “Una wey bi di sojas oga, make una kom. Make una find out who make di pipol sin today.
1SA 14:39 Bikos as long as God wey save Israel dey alive, even if na Jonatan my pikin kause am, e must die today!” But nobody for di sojas tok anytin.
1SA 14:40 Den e kon tell di sojas, “Una go dey dis side, why mi and my pikin Jonatan go dey di oda side.” Di sojas ansa Saul, “Make yu do wetin yu know sey dey good.”
1SA 14:41 Den Saul sey, “My Oga wey bi Israel God! Wetin make Yu neva ansa mi today? Ansa mi with di holy stone. If na mi or my pikin kause dis sin, den make Yu ansa by Urim; but if na yor pipol kause am, make Yu ansa by Tummim.” Den God pick Saul and en pikin thru dice wey dem trow and Israel pipol kon dey save.
1SA 14:42 Den Saul kon sey, “Make una trow di dice for mi and my pikin.” Wen dem trow am, e kon katch Jonatan.
1SA 14:43 So Saul tell Jonatan, “Tell mi wetin yu do.” Jonatan kon tell am, “I use my rod take taste small for di honey. I must die!”
1SA 14:44 Saul kon sey, “Make God ponish mi well-well, if I nor kill Jonatan!”
1SA 14:45 But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.
1SA 14:46 Den Saul stop to porshu Filistia pipol and dem kon go back to dia house.
1SA 14:47 Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.
1SA 14:48 E do great tins kon kill all Amalek pipol, den save Israel pipol from dia enemies hand.
1SA 14:49 Saul pikin dem name na Jonatan, Ishvi and Malki-Shua. E get two girls; di senior one na Merab, while di yonga one na Mikal.
1SA 14:50 Saul wife name na Ahinoam wey bi Ahimaaz pikin. Di oga for Saul sojas na Abner wey bi Ner pikin and Ner na Saul papa broda.
1SA 14:51 Na Abiel born Kish wey bi Saul papa and Ner wey bi Abner papa.
1SA 14:52 All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.
1SA 15:1 Den, Samuel kon tell Saul, “Na mi God send make e make yu king ova en pipol, Israel. Naw make yu listin to wetin God dey tok.
1SA 15:2 Dis na wetin God wey dey heaven dey tok: ‘I si as Amalek pipol dey trobol Israel pipol, wen dem dey kom out from Egypt.
1SA 15:3 So make yu go kill Amalek pipol. Yu go distroy evritin wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill evribody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.’ ”
1SA 15:4 So Saul gada en sojas kon kount dem for Telaim: Dem bi 200,000 sojas wey dey waka with leg and 10,000 men from Judah.
1SA 15:5 Saul kon go Amalek town, where e for hide en sojas for one river wey don dry.
1SA 15:6 Saul tell Kenite dem (Pipol wey dia grand-grand papa dey nice to Israel pipol) wey dey stay with Amalek pipol sey, “Make una komot from der, if not I go kill una join dis pipol!” So Ken pipol kon komot from der.
1SA 15:7 Den Saul kill Amalek pipol from Havilah go rish Shur wey dey near Egypt.
1SA 15:8 E katch Agag, wey bi Amalek pipol king, but e kill all en pipol with swod.
1SA 15:9 Saul and en sojas nor kill king Agag and dem nor distroy di betta tins and animals. Dem nor kill all di animals, but dem kill and distroy di tins wey nor good for di town.
1SA 15:10 Den God tell Samuel,
1SA 15:11 “I dey regret sey I make Saul king, bikos e don turn from mi and e nor do wetin I sey make e do.” Samuel kon vex well-well and e pray to God till day break.
1SA 15:12 Den Samuel stand up wen day neva break well-well kon go meet Saul. But dem tell Samuel sey, “Saul don go Karmel where e dey build image for ensef. Den Samuel go Gilgal.”
1SA 15:13 Wen Samuel meet Saul, Saul kon sey, “Make God bless yu! I don do wetin God tok.”
1SA 15:14 Samuel kon sey, “If na so e bi, wetin kon bi doz sheep and kattle nois wey I dey hear?”
1SA 15:15 Saul ansa, “I bring dem kom from Amalek; di sojas keep di best for di animals, so dat dem go sakrifice am to God. But wi kill evry oda tin.”
1SA 15:16 Den Samuel tell Saul, “Wait first! Make I tell yu wetin God tok yestiday nite.” Saul kon sey, “Make yu tell mi.”
1SA 15:17 Samuel sey, “Even doh yu feel sey yu nor dey important, yu still bikom God pipol king. Na God choose yu as king ova en pipol.
1SA 15:18 God send and tell yu sey, ‘Go kill all doz wiked Amalek pipol! Fight dem until yu don distroy all of dem.’
1SA 15:19 But, wetin make yu nor obey God? Wetin make yu pak some tins kom? Naw make yu know sey yu nor obey God and E dey vex for yu.”
1SA 15:20 Den Saul tell Samuel, “But I don obey God! I go as E send mi. I bring Amalek king, Agag kom back, afta I don kill all of dem finish.
1SA 15:21 But di sojas take some for di best animals and tins, so dat dem go sakrifice am to di Oga yor God for Gilgal.”
1SA 15:22 Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.
1SA 15:23 Bikos to go against am, bi like wen pesin chop witch and to dey show sturbon head, bi like wen yu dey woship juju. So bikos yu don rijet di word wey God tell yu, en ensef don rijet yu as king.”
1SA 15:24 Den Saul kon tell Samuel, “I don sin, bikos I nor obey God kommand and wetin yu tok. Bikos I dey fear di sojas, I kon follow wetin dem tok.
1SA 15:25 Naw! Abeg make yu forgive mi. Follow mi go, so dat I go-go woship God.”
1SA 15:26 But Samuel tell Saul, “I nor go-go with yu, bikos yu don rijet wetin God tok and God don rijet yu as king ova en pipol, Israel.”
1SA 15:27 Wen Samuel turn make e dey go, Saul kon try to hold en klot korna and di klot korna kon tear komot.
1SA 15:28 So, Samuel kon tell am, “God don tear Israel kingdom komot from yor hand today and E don gi-am to pesin wey betta pass yu!
1SA 15:29 God wey get Israel must do wetin E tok and E nor dey shange en mind, bikos E nor bi human being wey dey shange mind.”
1SA 15:30 Saul ansa again, “I know sey I don sin, but make yu nor disgrace mi before all dis pipol. Abeg, follow mi make wi go woship di Oga wey bi yor God.”
1SA 15:31 So, Samuel follow Saul go and Saul kon woship God.
1SA 15:32 Den Samuel sey, “Make una bring Amalek king, Agag, kom meet mi.” So dem bring Agag kom as e dey shake and e dey tink for en mind sey, “True-true, deat know sweet at-all!”
1SA 15:33 Samuel kon sey, “Just as yor swod kill pipol shidren kon make some wimen nor get pikin again, na so yor mama nor go ever get pikin again.” Den Samuel kut Agag to pieces for God present for Gilgal.
1SA 15:34 Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah.
1SA 15:35 Until di day wen Samuel die, Saul nor si am again. Samuel really sorry for Saul, but God regret sey E make Saul king ova Israel, en pipol.
1SA 16:1 God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”
1SA 16:2 Samuel ansa, “How I won take go? Saul go hear about am kon kill mi!” But God sey, “Take one small animal follow body kon sey, ‘I don kom sakrifice give God.’
1SA 16:3 Den invite Jesse kom di sakrifice and I go show yu wetin yu go do. Yu go anoint di pesin wey I go choose.”
1SA 16:4 Samuel kon do as God sey make e do. Wen e rish Betlehem, di eldas for di town dey fear to go meet am. So dem kon sey, “Hope yu kom with peace?”
1SA 16:5 Samuel ansa dem, “Yes! Na peace I bring kom. I won give God sakrifice.” So e santify Jesse and en pikin kon invite dem kom di sakrifice.
1SA 16:6 Wen den rish der, Samuel si Eliab kon sey, “True-true, na who God choose bi dis!”
1SA 16:7 But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”
1SA 16:8 Den Jesse koll Abinadab kom meet Samuel. But Samuel sey, “God nor choose dis one too.”
1SA 16:9 Den Jesse koll Shammah. But Samuel sey, “God nor choose dis one too.”
1SA 16:10 Jesse show Samuel en seven boys. But Samuel kon tell Jesse, “God nor choose any of dis ones.”
1SA 16:11 Samuel kon sey, “Dis na all di boys wey yu get?” Jesse ansa, “E still get di one wey small pass. E dey kare for di animals.” Den Samuel tell Jesse, “Make yu send pesin go koll am kom, bikos wi nor go fit do anytin until e kom here.”
1SA 16:12 So Jesse send for am. Di boy fine well-well, e strong and get fine eyes. God kon tell Samuel, “Na en bi dis! Make yu go anoint am!”
1SA 16:13 So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.
1SA 16:14 Naw, God Spirit don komot from Saul body and God kon send one wiked spirit make e dey ponish am.
1SA 16:15 Den Saul savant kon tell am, “Oga, si, one wiked spirit from God dey ponish yu!
1SA 16:16 Make awa oga tell wi yor savant make wi look for anybody wey sabi play jita. Den wen ever di wiked spirit kom from God kon enter yu, e go play di jita and yu go kon dey okay.”
1SA 16:17 So Saul tell en savants, “Make una fine one man wey sabi play di jita kom meet mi.”
1SA 16:18 One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”
1SA 16:19 So Saul kon send pipol go meet Jesse sey, “David, yor pikin wey dey kare for di sheep, make yu send am kom meet mi.”
1SA 16:20 So Jesse load one donkey with bread, one kontaina wey get wine and one goat kon send dem with en pikin David, go meet Saul.
1SA 16:21 David meet Saul kon stand for en front. Saul like am well-well, so David kon dey karry en swod.
1SA 16:22 Den Saul send pipol go tell Jesse sey, “Make David bi my savant, bikos I like am.”
1SA 16:23 So wen ever di spirit from God enter Saul, David go play music for am. Dis go make Saul dey okay and di wiked spirit go leave am.
1SA 17:1 Filistia pipol gada dia sojas to go fight. Dem gada for Soko wey dey Judah. Dia kamp dey for Efes-Dammim wey dey between Sokoh and Azeka.
1SA 17:2 Saul and Israel men kamp for Ela Valley where dem for dey ready to go fight Filistia pipol.
1SA 17:3 Filistia pipol stand for one side, while Israel pipol dey di oda side and na di valley separate dem.
1SA 17:4 Den di champion for Filistia pipol kamp kon kom out. En name na Goliat and e kom from Gat. E tall rish seven fit.
1SA 17:5 E wear bronze helmet for head and e wear iron koat wey heavy rish one hundred and twenty-five pounds.
1SA 17:6 Wetin e take protet en leg na bronze and di spear wey dey en shoulder na bronze too.
1SA 17:7 En spear mout tick well-well and di iron heavy rish fifteen pounds. Di pesin wey dey karry en shield, dey waka for en front.
1SA 17:8 E stand kon shaut for Israel pipol, “Wetin una dey do for der? Make una kom out kon fight? I bi Filistia pesin and una na Saul savants. Make una choose one of una man make e kon fight mi.
1SA 17:9 If e fight kon win mi, wi go bi una savants. But if I win and kill-am, una go bikom awa savant kon serve us.”
1SA 17:10 Den e kon sey, “I dey shalenge Israel sojas today sey, ‘Make una pick one pesin, make e kon fight mi!’ ”
1SA 17:11 Wen Saul and Israel pipol hear wetin di Filistia man tok, dem vex well-well and fear kon dey katch dem.
1SA 17:12 Naw, David na one Efrat man pikin and di man kom from Betlehem for Judah and en name na Jesse. Di man get eight boys and wen Saul dey rule, di man don old well-well.
1SA 17:13 Jesse three first boys don follow Saul go di war and dia names na, Eliab wey bi di first-born, sekond to Abinadab and Shammah wey bi di third.
1SA 17:14 Na David bi di last born among en papa sons, while di first three shidren dey follow Saul.
1SA 17:15 David dey go kom back from Saul palis, so dat e go fit take kare of en papa sheep for Betlehem.
1SA 17:16 So for forty days, di Filistia man dey kom out evry morning and evening dey shaut.
1SA 17:17 So one day, Jesse kon tell David, “Make yu take dis korn wey dem roast and ten bread go give yor brodas.
1SA 17:18 Den give dia oga dis biscuits. Make yu find out how yor brodas dey, den kom back kon tell mi weda dem get evritin wey I dey send yu go give dem.
1SA 17:19 Dem dey with Saul and Israel men wey won fight Filistia pipol for Ela Valley.”
1SA 17:20 So David get up before day break kon give en papa animal to pesin make e guide dem. Afta e don pak evritin, e kon go just as Jesse tell am. E rish di kamp as di sojas dey go di war front and dem dey sing war song.
1SA 17:21 Israel pipol and Filistia pipol stand opposite each oda and dem dey ready to fight.
1SA 17:22 Afta David don give wetin e karry kom to di pesin wey dey divide tins give di sojas, e kon run go di war front. Wen e rish der, e kon ask en brodas, how una dey?
1SA 17:23 As e dey tok to dem, Goliat di Filistia champion wey kom from Gat kon kom out from Filistia pipol side. E tok as e always dey do and David kon hear am.
1SA 17:24 Wen Israel men si Goliat, dem go hide, bikos of fear.
1SA 17:25 Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”
1SA 17:26 David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”
1SA 17:27 Di sojas kon tell am wetin di king promise, “Dis na wetin I go do for di man wey go kill Goliat.”
1SA 17:28 Wen en senior broda Eliab hear am dey tok to di men, e kon vex tell David, “Wetin make yu kom der? Na who yu sey make e guide doz sheep for di desert? I know sey yu like to show yorsef! Yu just kom here to wosh di fight!”
1SA 17:29 David ansa am, “Wetin I don do naw? I nor go fit tok anytin again?”
1SA 17:30 Den, David waka komot der kon go ask anoda pesin di same kweshon, but dem gi-am di same ansa.
1SA 17:31 Wen dem hear wetin David tok, dem kon tell Saul. So Saul kon koll David.
1SA 17:32 David tell Saul, “Nor let anybody mind fail am. Yor savant go-go fight dis Filistia man!”
1SA 17:33 But Saul ansa David, “Yu nor go fit fight dis Filistia man, bikos e don tey wen dis man don dey fight and yu still small!”
1SA 17:34 David ansa Saul, “Yor savant dey guide animal for en papa. Wen ever lion or bear or wild animals kon karry one sheep from di odas,
1SA 17:35 I go porshu di animal, nak am fall kon save di sheep from en mout. If e stand up won fight, I go hold en neck, nak and kill-am.
1SA 17:36 Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”
1SA 17:37 David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!” Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”
1SA 17:38 Den Saul wear wetin e take dey fight put for David body kon put en bronze helmet for en head. E still put iron shirt for en body.
1SA 17:39 David put en swod for di tins wey e wear to go fight and e kon try to waka, but e nor fit waka, bikos e nor dey use dem before. David kon tell Saul, “I nor fit waka with dis tins, bikos I neva use dem before.” So David kon remove dem.
1SA 17:40 David karry en stik for en hand kon pick five good stone from di stream, den e put dem for en animal bag. E take en katapault kon dey go meet di Filistia man.
1SA 17:41 Di Filistia man with di pesin wey karry en swod kon dey waka kom meet David.
1SA 17:42 Wen di Filistia man near David, e kon vex well-well, bikos na small and fine boy e bi.
1SA 17:43 Di Filistia man tell David, “I bi dog wey yu dey kom meet with stik?” Di Filistia man kon use en juju name take curse David.
1SA 17:44 E tell am, “Kom meet mi, so dat I go give yor flesh to di birds for sky and wild animals for di field, make dem chop.”
1SA 17:45 But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.
1SA 17:46 Today, God go give yu to mi. I go kill yu for groun kon kut yor head komot. I go give yor dead body to di bird for di sky and di wild animals for di land. Den all di land go know sey Israel pipol get betta God
1SA 17:47 and evribody for here go know sey nor bi by swod or spear, God dey take save pesin. Bikos na God get di fight and E go give yu to us.”
1SA 17:48 Goliat kon waka dey kom meet David, so dat e go attack am, den David kwik-kwik run go front go attack Goliat.
1SA 17:49 David put en hand inside di bag kon take one stone. E put am for di katapault kon shot di Filistia man for en head. Di stone enter en fore head well-well and e kon fall face groun.
1SA 17:50 David win di Filistia man with di katapault and stone. E shot di Filistia man fall kon kill-am. David nor even get swod for en hand.
1SA 17:51 So e run go stand near di Filistia man kon take en swod take kill-am, den e kut en head komot with di swod. Wen Filistia pipol si sey dia champion don die, dem kon bigin run.
1SA 17:52 Den di men for Israel and Judah kon bigin sing war song. Dem porshu Filistia pipol go rish di valley and Ekron gate. Di Filistia man dead body dey groun for Shaaraim road wey dem dey pass go Gat and Ekron.
1SA 17:53 Wen Israel sojas kom back, dem kon karry evritin for Filistia pipol kamp.
1SA 17:54 David take Goliat head go Jerusalem and e put Goliat swod for di tent.
1SA 17:55 As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?” Abner ansa, “My king, I nor know.”
1SA 17:56 Di king kon sey, “Make yu go find out wish pesin pikin e bi?”
1SA 17:57 So wen David kom back afta e don kill di Filistia man, Abner kon take am go meet Saul. David still hold Goliat head for en hand.
1SA 17:58 Saul ask am, “My pikin! Na wish pesin pikin yu bi? Who bi yor papa?” David ansa, “Jesse wey bi yor savant wey kom from Betlehem, naim bi my papa.”
1SA 18:1 Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.
1SA 18:2 Dat day, Saul take David and e nor let am go house go meet en papa.
1SA 18:3 Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life.
1SA 18:4 Jonatan remove di gown wey e wear kon gi-am to David, plus en gear, en swod, en bow and even en belt.
1SA 18:5 Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.
1SA 18:6 Wen dem kom back afta David don kill Filistia pipol, di wimen for di town kom out kon dey sing, dey dance go meet King Saul. Dem dey happy as dem dey play dia instruments dey kom.
1SA 18:7 Di wimen wey dey play di music kon dey sing sey, “Saul kill 1,000, but David don kill tazon times tazon pipol.”
1SA 18:8 Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”
1SA 18:9 So Saul kon dey look David one kind from dat day go.
1SA 18:10 Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,
1SA 18:11 den Saul trow di spear, bikos e tink for en mind sey, “I go nail David for di wall!” But David dodge am two difren times.
1SA 18:12 So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David.
1SA 18:13 Saul sey make David komot en present, but e still make am di sojas oga. David dey karry di sojas go war and bring dem back.
1SA 18:14 David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.
1SA 18:15 Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am.
1SA 18:16 But evribody for Israel and Judah like David, bikos na en dey take dem go war and bring dem back.
1SA 18:17 Den Saul tell David, “Na my senior girl bi dis, en name na Merab. I wont make yu marry am. I just wont make yu dey strong for mi and fight God war.” Bikos Saul tink sey, “No nid for mi to kill-am, make Filistia pipol kill-am!”
1SA 18:18 David kon tell Saul, “Who I bi? Who bi my family or my papa tribe for Israel wen I go kom bi di king in-law?”
1SA 18:19 Wen di time rish wen dem won give Saul pikin, Merab to David, dem kon give di girl to Adriel wey kom from Meholah.
1SA 18:20 Mikal wey bi Saul pikin, like David. Wen dem tell Saul wetin dey happen, en belle kon sweet am.
1SA 18:21 Saul kon sey, “I go give Mikal to David, so dat Mikal go bi trap for am and Filistia pipol go kill-am.” So Saul tell David, “Today, na di sekond time for yu to bi my in-law.”
1SA 18:22 Den Saul tell en savant, “Make yu use brain tell David for korna sey, ‘Di King dey happy with yu and all en savants like yu. So make yu marry di king pikin.’ ”
1SA 18:23 So Saul savant go tell David wetin di king tell am make e do. David ansa, “Na betta honor to marry di king pikin. Di honor too mush for pesin like mi wey nor bi anytin!”
1SA 18:24 Wen Saul savants tell am wetin David tok,
1SA 18:25 Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
1SA 18:26 So en savants tell David and David gri sey e go marry di king pikin. Naw, di time wey di king give David neva pass,
1SA 18:27 den David with en men go fight kon kill two hundred Filistia pipol. David take dia skin go give Saul, so dat e go fit marry di king pikin. So Saul give en pikin Mikal to David make e marry.
1SA 18:28 Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,
1SA 18:29 e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.
1SA 18:30 Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.
1SA 19:1 Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well.
1SA 19:2 So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.
1SA 19:3 I go-go meet my papa for di field where yu dey kon ask about yu. Wen e tell mi di problem, I go kom tell yu.”
1SA 19:4 So Jonatan tok to en papa about David, “Make di king nor sin against en savant David, bikos e neva sin against di king. To tink am sef, David don really help di king.
1SA 19:5 E risk en life wen e fight and kill Filistia pipol. God win big viktory for Israel pipol. Wen yu si and hear am, yu yorsef kon dey happy. So wetin go make yu won sin against pesin wey nor do any bad tin? Wetin go make yu won kill David yor savant for no rizin?”
1SA 19:6 Saul gri with en pikin Jonatan kon swear sey, “As long as God dey alive, nobody go kill David.”
1SA 19:7 Den Jonatan bring David kon meet Saul and di boy kon dey serve am as e dey do before.
1SA 19:8 War kon start again. So David kon go fight Filistia pipol. E win dem well-well and di remainin ones, run from am.
1SA 19:9 Den one wiked spirit from God kon enter Saul again. E sidan for en house with en spear for en hand, while David dey play di jita.
1SA 19:10 Saul kon try to nail David for di wall with en spear, but David dodge komot from Saul front and di spear kon pin for di wall. David kwik-kwik run go hide dat nite.
1SA 19:11 Saul send pipol go guide David house and make dem kill-am wen day break. Den David wife, Mikal tell David, “If yu nor save yorsef dis nite, by dis time tumoro, yu go don bikom dead body!”
1SA 19:12 So di woman help David pass thru window and e kon run.
1SA 19:13 Den Mikal take one doll-baby for di house kon put am for bed. E put goat hair for di doll-baby head kon kover am with klot.
1SA 19:14 Wen Saul send pipol make dem go arrest David kom, Mikal kon tell dem, “David nor well.”
1SA 19:15 Den Saul send pipol go back sey, “Make una karry am kom like dat, so dat I go kill-am with my hand.”
1SA 19:16 Wen di pipol rish der, dem kon si only di doll-baby for di bed wey dem put goat hair for en head.
1SA 19:17 So, Saul tell Mikal, “Wetin make yu deceive mi like dis kon make my enemy run? Naw, e don eskape.” Mikal kon ansa, “E sey, ‘If yu nor help mi run, I go kill yu before yor papa kill mi.’ ”
1SA 19:18 Naw, David don run go hide. E run go meet Samuel for Rama kon tell am evritin wey Saul do am. Den en and Samuel kon go stay Naiot.
1SA 19:19 Dem kon tell Saul sey, “David dey Naiot for Rama.”
1SA 19:20 So Saul send men go katch David kom. Wen di men si some profet dey tok wetin go happen with Samuel as dia leaders, God Spirit kon enter dem and demsef kon dey tok like di profets.
1SA 19:21 Wen Saul hear wetin happen to en men, e kon send anoda set go, but di same tin happen to dem too. So e send di third set go and dem kon join di rest dey tok like di profets.
1SA 19:22 Den Saul kon go Rama by ensef. Wen e rish di big well for Seku, e kon ask, “Where Samuel and David dey?” Dem ansa am, “Dem dey for Naiot wey dey Rama.”
1SA 19:23 So Saul go Naiot for Rama. God Spirit kon enter en body and e kon bigin tok wetin go happen as e dey waka till e rish Naiot for Rama.
1SA 19:24 E even tear en klot komot from en body kon dey tell Samuel wetin go happen. E sleep naked for der from morning till di next day. Na dis tin make pipol dey ask weda, “Saul sef don bi profet?”
1SA 20:1 David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”
1SA 20:2 Jonatan ansa am, “Nor-tin go fit kill yu! My papa nor go fit do anytin escept e tell mi first. Wetin make my papa nor gri tell mi about dis matter? E nor go fit happen!”
1SA 20:3 But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”
1SA 20:4 Jonatan ansa David, “Tell mi wetin yu wont make I do for yu.”
1SA 20:5 David ansa, “Tumoro na new moon and I suppose dey with di king for evening food. I go-go hide for di field for like three evening.
1SA 20:6 If yor papa notis sey I nor dey di tabol, make yu tell am sey, ‘I beg yu make I go Betlehem, bikos di time wey di whole family dey sakrifice evry year, don rish.’
1SA 20:7 If yor papa kon sey, ‘No wahala,’ den make yu know sey I dey save. But if e vex, make yu know sey e won kill mi.
1SA 20:8 Abeg, make yu do dis favor for mi, bikos yu don promise yor savant with God name. If I do wrong, na yu go kill mi my yorsef! Wetin go make yu take mi go meet yor papa?”
1SA 20:9 Jonatan kon ansa, “Make yu nor even tink like dat! If to sey I know since sey my papa won kill yu, nor bi mi go first tell yu about am?”
1SA 20:10 David kon tell Jonatan, “Who go kom tell mi if yor papa nor ansa yu well?”
1SA 20:11 Jonatan ansa David, “Kom make wi go di field.” Wen dem two dey go di field,
1SA 20:12 Jonatan tell David, “Di Oga wey bi Israel God na my witness. I go tell my papa dis tin for di day afta tumoro. If wetin e tok favor David, I nor go send word kon give yu?
1SA 20:13 But if really sey my papa get mind to kill yu, make God do all dis tin and many more to Jonatan if I nor kon tell yu, so dat yu go run go hide. Make God dey with yu, as E bin dey with my papa.
1SA 20:14 As long as I dey, make yu keep yor promise to mi, but if I die,
1SA 20:15 make yu show di same love wey yu get for mi to my family forever. Wen God don kill all yor enemies finish,
1SA 20:16 make awa promise to each oda nor break. If e break, God go ponish yu.” So Jonatan kon enter kovenant with David family.
1SA 20:17 Jonatan still swear again with David, bikos e love am. Jonatan love David as e love en own life.
1SA 20:18 Jonatan tell David, “Tumoro na new moon and I go miss yu, bikos yor seat go dey empty.
1SA 20:19 For di third day, yu go-go stay for di place where yu first hide put wen all dis tins start. Make yu stay near Ezel Stone.
1SA 20:20 I go shot three arrow near am like sey I dey target sometin.
1SA 20:21 I go send one boy sey, ‘Go find di arrow.’ If I tell di boy sey, ‘Si, di arrow dem dey dis side, go find dem,’ den make yu kom. Bikos as long as God dey alive, yu go dey save from all di wahala.
1SA 20:22 But if I tell di boy, ‘Si, di arrow dem dey di oda side’, den make yu run go. Dat mean sey God don sey make yu run.
1SA 20:23 Koncerning di tin wey mi and yu tok, God na awa witness forever!”
1SA 20:24 So David kon hide for di field. Wen di new moon kom out, di king kon sidan to chop en food.
1SA 20:25 Di king sidan for where e dey sidan before near di wall, den Jonatan sidan face am and Abner sidan for en side. But David chair dey empty.
1SA 20:26 Dat day, Saul nor tok anytin about am, bikos e tink sey sometin don happen wey make David nor dey okay to kom chop di food.
1SA 20:27 But di next morning for di sekond day for di new moon, David seat still dey empty. So Saul kon tell en pikin Jonatan, “Wetin make Jesse pikin neva kom chop for dis tabol? E nor kom yestiday and e nor dey here today.”
1SA 20:28 Jonatan ansa en papa, “David ask mi make I let am go Betlehem.
1SA 20:29 E sey, ‘Abeg, make yu let mi go, bikos wi get family sakrifice for di town and my brodas sey make I dey der. So if yu bi my friend, make yu let mi go.’ Na dis make am nor dey di king tabol.”
1SA 20:30 Saul vex well-well with Jonatan den e kon tell am, “Yu nor get papa! Na naw I know sey yu dey support David and yu dey disgrace yorsef and yor mama!
1SA 20:31 Yu nor know sey as long as David dey alive, yu nor go ever bi king for Israel? Naw, make yu go bring am kom here, bikos e must die!”
1SA 20:32 Jonatan kon ask en papa, “Wetin go make am die? Wetin e do wey go make dem kill-am?”
1SA 20:33 Den Saul trow en spear face Jonatan, so dat e go pin am for groun. Den Jonatan kon know sey en papa won kill David.
1SA 20:34 Jonatan stand up from di tabol with vexnashon and dat day, e nor chop anytin, bikos e dey vex sey en papa won kill David.
1SA 20:35 Di next morning, Jonatan with en boy savant kon go di field go meet David.
1SA 20:36 E kon tell en savant, “Make yu run go find di arrow wey I won shot so.” As di savant dey run, Jonatan shot di arrow pass am.
1SA 20:37 Wen di savant rish di place where di arrow for land, Jonatan kon shaut koll am sey, “Di arrow still dey yor front?”
1SA 20:38 Jonatan koll di savant, “Make yu kwik! Run go kwik-kwik! Nor stop!” Jonatan savant take di arrow kon kom back kom meet en oga.
1SA 20:39 Di savant nor undastand wetin dey happen. Na only Jonatan and David know wetin dey happen.
1SA 20:40 Den Jonatan karry en swod bag give di boy wey dey with am. E kon tell am, “Make yu dey go, karry dis tins go back to di town.”
1SA 20:41 Wen di savant don go, David stand kom out from where e hide put near di stone, e knee down kon bow three times. Den dem kiss each oda kon bigin kry, but na David kry pass.
1SA 20:42 Jonatan kon tell David, “Make yu go well, bikos di two of us don use God name take swear sey, ‘God go dey with mi and yu and even awa shidren-shidren forever.’ ” Den David get up kon run go, while Jonatan go back to di town.
1SA 21:1 David go meet Ahimelek wey bi Nob priest. Ahimelek dey fear wen e meet David, so e kon tell am, “Wetin make only yu dey waka without bodyguard?”
1SA 21:2 David kon ansa, “Di king sey make I do sometin and e sey, ‘Nor let anybody know why I dey send yu or tell yu dis tins.’ I don tell my sojas make dem wait for one place.
1SA 21:3 So naw wetin yu get? Make yu give mi five bread or anytin wey yu si.”
1SA 21:4 Di priest ansa David, “I nor get ordinary bread, na only di holy bread dey and di sojas go fit chop am if dem nor sleep with woman.”
1SA 21:5 David tell di priest, “True-true, dem nor dey sleep with wimen wen wi dey go war. Dia swods sef dey holy, even doh na ordinary journey wi dey go. So today, dem even dey holy well-well!”
1SA 21:6 So di priest give David di holy bread, bikos no oda bread dey der. Dem take am from God present, so dat dem go put hot ones for der.
1SA 21:7 One of Saul savant dey der dat day, bikos e nid to do some tins wey God tell am. En name na Doeg wey kom from Edom and na en dey kare for Saul animals.
1SA 21:8 David ask Ahimelek, “Yu nor get any spear or swod for here? I don forget my own, bikos I dey rush kom here.”
1SA 21:9 Di priest ansa, “Goliat, Filistia pipol wey yu kill for Ela Valley, na only en swod wey dem wrap with klot put for di efod back, dey here. If yu wont am, make only yu go take am. Anytin wey pass dat one, nor dey here.” David kon sey, “Nor-tin good rish dat one! Make yu give mi!”
1SA 21:10 So dat day, David kon run from Saul go meet King Akish for Gat.
1SA 21:11 King Akish savant kon ask di king, “Nor bi David bi dis, David wey bi king for en kountry? Nor bi en pipol dey sing sey, “ ‘Saul kill 1,000, but David kill tazon plus tazon.’ ”
1SA 21:12 David tink wetin dem tok for en mind kon dey fear King Akish for Gat.
1SA 21:13 So wen David dey with dem, e bihave like sey e dey mad. Since e dey under dia pawa, e dey do like mad pesin kon dey rite for dia town gate, while spit go dey rush komot en mout.
1SA 21:14 Akish kon tell en savant, “Si dis mad man! Wetin make yu bring am kom meet mi?
1SA 21:15 Di mumu dem wey I get nor plenty rish? Why yu bring dis kraze man kom my front? Yu wont make dis mad man enter my house?”
1SA 22:1 So, David run komot der kon go stay for one hole near Adullam town. Wen en brodas and family hear sey e dey der, dem kon go meet am.
1SA 22:2 Doz wey dey face trobol or owe pesin or wey nor get wetin to do kon gada follow David and e kon dey lead dem.
1SA 22:3 Den, David from der go Mizpa for Moab, where e for tell Moab king sey, “I beg! Make yu allow my papa and mama stay with yu until I know wetin God won take mi do.”
1SA 22:4 So David papa and mama kon stay with Moab king; dem stay with di king thru-out di time wey David dey run waka.
1SA 22:5 Den Profet Gad kon tell David, “Nor hide for hole again, but make yu go Judah go stay.” So David kon go Heret Forest.
1SA 22:6 But dem kon tell Saul where David and di pipol wey dey with am dey stay. Saul sidan for Gibeah under one tamarisk tree for one high place with en spear for en hand and all en savants gada round am.
1SA 22:7 Saul tell dem, “All of una wey kom from Benjamin tribe! Make una listin! Jesse pikin don give field and vineyard to any of una before? Or e don make any of una kommander and offisa?
1SA 22:8 Nobody fit kon even tell mi wen my own pikin enter agriment with dis David. Non of una even fit sorry kon tell mi sey my own pikin don allow my savant set trap for mi, just as e bi today so.”
1SA 22:9 But Doeg wey kom from Edom, wey dey among Saul savants kon ansa di king, “I si David wen e go meet Ahitub pikin Ahimelek for Nob.
1SA 22:10 E tok to God for am kon give David some food and oda tins. E still gi-am Goliat, di Filistia giant, swod.”
1SA 22:11 Den di king send for Priest Ahimelek, wey bi Ahitub pikin and all di priest wey dey en own papa house for Nob. So all of dem kom meet di king.
1SA 22:12 Den Saul sey, “Ahitub pikin, make yu listin.” Ahimelek kon ansa, “My oga, I dey hear yu.”
1SA 22:13 Saul ask am, “Wetin make yu join plan against mi; yu and David? Yu gi-am bread and swod kon tok to God for am, so dat e go oppoz mi kon set trap for mi, just as di matter bi today?”
1SA 22:14 Ahimelek ansa di king, “For all di savant wey yu get, na wish one dey good rish David? David na di king pikin husband, na en bi oga for di king sojas and e dey work for yor house.
1SA 22:15 Na today bi di first day wey I dey tok to God for am? E nor fit happen! Make di king nor blame en savant or evry priest for my papa house. Bikos yor savant nor know anytin wey dey happen at-all.”
1SA 22:16 But di king sey, “Ahimelek, yu must die, both yu and evribody for yor papa house!”
1SA 22:17 Den di king tell di pipol wey dey with am sey, “Make una go kill God priests. Bikos dem don join David side. Dem know sey e dey run, but dem nor kom tell mi.” But di king savants nor gri tosh God priest.
1SA 22:18 Den di king kon tell Doeg, “Make yu kill di priests.” So Doeg wey kom from Edom kon turn kill di priests. For dat day, e kill eight five men wey wear linen priest garment.
1SA 22:19 Den e kon go Nob wey bi priests town kon kill evribody for der, both men and wimen, yong and small pikin, plus all dia animals.
1SA 22:20 But one of Ahimelek pikin run go meet David. En name na Abiatar.
1SA 22:21 Abiatar kon tell David evritin, how Saul take kill God priest.
1SA 22:22 Den David tell Abiatar, “I know dat day sey, since Doeg wey kom from Edom dey der, e must tell King Saul. Na mi dem go blame for di deat wey yor papa and en family don die so.
1SA 22:23 So, make yu stay with mi and yu go dey save. Make yu nor fear, bikos Saul won kill di two of us.”
1SA 23:1 Dem kon tell David, “Filistia pipol dey fight for Keilah and dem dey karry dia tins go.”
1SA 23:2 So David ask God, “Make I go kill all dis Filistia pipol?” God ansa David, “Make yu go kill Filistia pipol kon diliver Keilah pipol.”
1SA 23:3 But David men kon tell am, “Wi still dey fear as wi dey here for Judah! How e go kom bi if wi go fight Filistia sojas for Keilah?”
1SA 23:4 So David ask God again. But God tell am again sey, “Make yu go save Keilah pipol. Bikos I don put Filistia pipol for yor hand.”
1SA 23:5 So David and en men kon go Keilah go fight Filistia pipol. E karry dia animals kon kill dem well-well. Na so David take save Keilah pipol.
1SA 23:6 Naw, wen Ahimelek son, Abiatar don run go meet David for Keilah, e karry one efod follow body.
1SA 23:7 Wen dem tell Saul sey David dey Keilah, Saul kon sey, “Today, God don put David for my hand, bikos e don put ensef for tight korna wen e enter town wey get only two gate and big-big iron.”
1SA 23:8 So Saul gada all en sojas, so dat dem go-go katch David and en men for Keilah.
1SA 23:9 Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”
1SA 23:10 Den David sey, “My Oga wey bi Israel God, yor savant don hear sey Saul dey plan to kom distroy di town bikos of mi.
1SA 23:11 Di leaders for Keilah go put mi for en hand? Saul go kom as dem tell mi yor savant? My Oga wey bi Israel God, abeg make Yu tell mi.” Den God ansa, “E go kom.”
1SA 23:12 David kon ask, “Keilah leaders go give mi and my men to Saul?” God sey, “Dem go give una to am.”
1SA 23:13 So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.
1SA 23:14 David kon hide for di hill near Zif desert. Saul dey find David, but God nor let am katch am.
1SA 23:15 David know sey Saul dey find am bikos e won kill-am, so e go stay Horesh for Zif desert.
1SA 23:16 Den Saul pikin Jonatan go meet David for Horesh kon tell am, “God go always guide yu.”
1SA 23:17 E tell am, “Make yu nor fear, bikos my papa hand nor go fit tosh yu at-all. Yu go rule Israel and I go dey by yor side. Even my papa know sey na so e go bi.”
1SA 23:18 Wen di two of dem don make kovenant for God present, David stay for Horesh, but Jonatan kon go house back.
1SA 23:19 Den Zif pipol go tell Saul for Gibeah sey, “David dey hide for Horesh near Hakilah Hill wey dey Jeshimon sout.”
1SA 23:20 Di pipol still sey, “Awa king, wi know how yu really one katch David; so make yu kom awa aria and wi go make sure sey yu katch am.”
1SA 23:21 Saul ansa, “Make God bless una, bikos una don sorry for mi.
1SA 23:22 Make una go make betta plan and know where e really dey and di pesin wey si am. Bikos dem tell mi sey e get sense well-well.
1SA 23:23 Make una take time find di real place wey e dey, den kon tell mi. Den I go follow una go. If e dey di land, I go find am among doz wey dey Judah.”
1SA 23:24 So dem leave Saul kon go back to Zif. Naw, David and en men dey inside Maon desert for Arabah wey dey Jeshimon sout.
1SA 23:25 Saul and en men kon go look for David. But dem tell David, so e kon go stay di rock for Maon desert. Wen Saul hear sey e dey der, e kon porshu David go Maon desert.
1SA 23:26 Saul pass one side for di mountin, while David and en men pass anoda side for di mountin. David dey hurry, so dat Saul nor go katch am, but Saul and en men don surround David and en men well-well.
1SA 23:27 But one pesin run kon tell Saul, “Make yu kwik-kwik kom, bikos Filistia pipol don dey skata di land!”
1SA 23:28 So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot.
1SA 23:29 Den, David komot der kon go stay where strong pass for En-Gedi.
1SA 24:1 Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
1SA 24:2 So Saul take 3,000 men wey e selet from Israel kon go find David and en men for di aria wey rock dey for where goats for mountin dey stay.
1SA 24:3 E rish one place where sheep dey for di road side and rock wey whole dey inside, dey der too. Den e go inside di rock go rest. Naw, David and en men sidan for di rock back (Dem hide for der).
1SA 24:4 David men kon tell am, “Today na di day wey God tell yu about sey, ‘I go put yor enemy for yor hand and yu fit do am anytin wey yu like.’ ” So David kon stand up small-small go kut di korna for Saul klot.
1SA 24:5 Leta, David mind kon dey judge am, bikos e kut Saul klot,
1SA 24:6 so e kon tell en men, “Make God nor let mi do bad tin to my oga, di king wey E choose. Afta all, na God choose am.”
1SA 24:7 David beg en men with di words wey e tok, so dem nor kon do King Saul anytin. But wen Saul don komot from di rock kon bigin go,
1SA 24:8 David kom out from di rock kon shaut make Saul for hear, “My oga, di king!” Wen Saul look en back, David bow face groun for am.
1SA 24:9 David tell Saul, “Wetin make yu dey listin to pipol wey sey, ‘David won kill yu?’
1SA 24:10 Yu yorsef go know sey today God don put yu for my hand for inside di rock. Some of my men sey make I kill yu, but I sorry for yu kon sey, ‘I nor go do bad tin to my oga, bikos na God choose am.’
1SA 24:11 My papa, si yor klot korna for my hand. Wen I kut am komot, I nor kill yu. So make yu know and undastand sey I nor dey plan to kill or fight against yu.
1SA 24:12 Make God judge between mi and yu and e go save mi from yor hand, but I nor go tosh yu with my hand.
1SA 24:13 E bi like dis proverb: ‘Bad tins dey kom out from bad pipol.’ But my hand nor go tosh yu.
1SA 24:14 “Na who Israel king dey look for? Na who e dey porshu? Dog wey don die or ordinary ant?
1SA 24:15 Make God judge di matter kon tok who dey rite and wrong. Make e kom defend and save mi from yu!”
1SA 24:16 Wen David don tok finish, Saul kon sey, “David, My pikin! Na yor vois bi dat?” Den Saul kry well-well.
1SA 24:17 E kon tell David, “Yu betta pass mi, bikos since I know yu, yu dey good to mi, even doh I dey try to kill yu.
1SA 24:18 Yu don show mi today how yu good rish, bikos yu nor gri kill mi, even doh God put mi for yor hand.
1SA 24:19 If pesin katch en enemy, e dey tell am make e go without sey e wound am? Today! Make God reward yu with good, bikos of wetin yu do to mi.
1SA 24:20 Si naw, I don know sey na yu really go bi king and yu go build Israel kingdom with yor hand.
1SA 24:21 So naw, make yu use God name take swear sey yu nor go kill mi, my shidren or shidren-shidren or distroy my name from my papa house.”
1SA 24:22 David kon promise Saul. Den Saul kon go en house and David and en men kon go where dem go for dey save.
1SA 25:1 Samuel die and evribody for Israel gada kon mourn for am. Dem beri am for en house for Rama. Den David kon go Paran desert.
1SA 25:2 E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.
1SA 25:3 Di man name na Nabal and en wife na Abigail. Di woman get sense and e fine well-well, but di man bad and na wiked tins e dey do. Na Kaleb tribe e from kom.
1SA 25:4 Wen David hear for inside di desert sey Nabal dey barb en sheep hair,
1SA 25:5 e send ten savant kon tell dem, “Make una go meet Nabal for Karmel kon tell am sey I dey greet am.
1SA 25:6 Den una go tell am, ‘Make peace dey with yu and yor house! Make peace dey with evritin wey bi yor own!
1SA 25:7 “ ‘Naw, I hear sey pipol dey barb sheep for yu. Wen yor pipol wey dey guide di sheep dey with us for Karmel, wi nor curse or fight dem.
1SA 25:8 Ask yor savants and e go tell yu! Make yu favor yor savants, bikos na holiday wi kom for. Abeg make yu give yor savant and David anytin wey yu go fit give us.’ ”
1SA 25:9 So David savants go tell Nabal all dis word with David name. Den dem nor tok again.
1SA 25:10 But Nabal tell David savants, “Na who bi David and na who bi dis Jesse pikin sef? Na dis kind time many savants dey run leave dia oga.
1SA 25:11 Make I give una di bread, wota and meat wey I won give doz wey dey barb di sheep? I nor even know where una from kom!”
1SA 25:12 So David savant kon go back. Wen dem kom back, dem tell David evritin.
1SA 25:13 Den David kommand en men, “Make una karry una swod,” and David karry en swod too. Like four hundred men kon follow David, while two hundred dey house with evritin wey dem get.
1SA 25:14 But one savant kon tell Abigail, Nabal wife sey, “David send pipol from desert make dem kon greet awa oga, but awa oga shaut give dem.
1SA 25:15 Di men dem dey good to us. Dem nor curse or wound us wen wi dey with dem for di field.
1SA 25:16 Both for nite and day time, dem dey guide us wen wi dey guide awa sheep.
1SA 25:17 Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”
1SA 25:18 So Abigail kon kwik-kwik take two hundred bread, two kontaina wey wine full, five sheep wey dem don barb well, hundred raisin and two hundred fig fruits wey dem don press. Abigail pak dem put on-top donkey
1SA 25:19 kon tell en savant, “Make yu go for my front. I dey kom for yor back.” But e nor tell Nabal wey bi en husband.
1SA 25:20 As Abigail dey ride en donkey pass under di mountin, e kon meet David and en men for road.
1SA 25:21 Naw, David dey tink for en mind sey, “As I guide evritin wey bi dis man own for desert rish, so e nor mean anytin to am? I nor take anytin from am. But e don use wikedness take pay di good wey I do for am.
1SA 25:22 Make God ponish mi if by tumoro one of en family still dey alive!”
1SA 25:23 Wen Abigail si David, e kwik-kwik kom down from di donkey kon bow for am.
1SA 25:24 Abigail fall for groun kon sey, “My oga, I gri sey wi dey wrong. But abeg make yu let yor woman savant follow yu tok. Make yu listin to wetin yor savant get to tok.
1SA 25:25 My oga, make yu nor listin to dat wiked Nabal. E dey bihave like en name! En name mean ‘Fool’ and e really bi fool. But mi yor savant nor si di men wey yu send kom.
1SA 25:26 “Naw my oga, as long as God dey alive and as long as yu dey alive too, God nor go let yu kill or do tins di way yu wont am. Naw, make yor enemies and doz wey dey try to wound yu, bi like Nabal.
1SA 25:27 So my oga, make yu allow yor savants take dis gift dem wey I bring kom give yu.
1SA 25:28 Abeg, make yu forgive di sin wey wi kommit and true-true God go make yor house great, bikos yu dey fight God fight. All di days wey yu go stay for dis eart, yu nor go put hand for bad tin.
1SA 25:29 Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.
1SA 25:30 God go do evritin wey E promise yu and E go make yu oga ova Israel pipol.
1SA 25:31 Yor mind nor go judge yu bikos yu kill pipol wey nor do wrong or pay pipol back for wetin dem do yu. Wen God don give yu, my oga viktory, abeg make yu remember mi.”
1SA 25:32 Den David kon tell Abigail, “Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey don send yu kom meet mi today!
1SA 25:33 God bless yu as yu take judge di kase! Make God reward yu, bikos yu nor let mi kill pipol kon do as my own mind dey tell mi.
1SA 25:34 If not, as long as di Oga wey bi Israel God dey alive, di pesin wey stop mi to kill una, if to sey yu nor kwik meet mi, by tumoro morning, no singol boy for Nabal family for dey alive.”
1SA 25:35 Den David kollect di gifts kon tell Abigail, “Make yu go back to yor house in peace. Bilive sey I don hear wetin yu tok and nor-tin go happen to una.”
1SA 25:36 Wen Abigail go back go meet Nabal, e dey do party for en house like king. Nabal dey enjoy ensef and e don drink well-well. Abigail nor tok anytin until di next day.
1SA 25:37 Wen day break wen Nabal eye neva klear well-well, en wife kon tell am wetin happen. Na wons e get stroke and e nor fit waka again.
1SA 25:38 Afta like ten days, God nak Nabal and e kon die.
1SA 25:39 Wen David hear sey Nabal don die, e kon sey, “Make wi praiz God wey don fight for us, bikos of wetin Nabal do. God stop en savant to do bad and E don reward Nabal with di wiked wey e do.” Den David send pipol go meet Abigail sey make e bi en wife.
1SA 25:40 So David savant go meet Abigail for Karmel kon tell am, “Na David send us kom bring yu as en wife.”
1SA 25:41 Abigail stand up, bow face groun kon sey, “Yor woman savant wey dey alone, go wosh my oga savants leg.”
1SA 25:42 Den Abigail kwik-kwik klimb donkey with five of en woman savants. E follow pipol wey David send kom kon go meet David and e kon bi en wife.
1SA 25:43 David don already marry Ahinoam from Jezrel and di two of dem kon bi en wife.
1SA 25:44 Naw, Saul don give en pikin Mikal wey bi David wife to Laish pikin, Paltiel wey kom from Gallim.
1SA 26:1 Zif pipol kom meet Saul for Gibeah sey, “David hide for Hakilah hill wey dey near Jeshimon.”
1SA 26:2 So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert.
1SA 26:3 Saul kamp for di road wey dey near Hakilah hill near Jeshimon, but David dey inside di desert. Wen David know sey Saul dey di desert dey find am,
1SA 26:4 e kon send pipol go spy if na true.
1SA 26:5 So David kon go di place where Saul kamp put. E si where Saul, Ner pikin Abner and en sojas sleep put. Saul sleep inside di kamp, while en sojas kon sleep round am.
1SA 26:6 David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?” Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”
1SA 26:7 So David and Abishai kon rish der dat nite and dem si sey Saul dey sleep inside di kamp and e pin en spear for groun near en head. Abner and di sojas sleep around am.
1SA 26:8 Abishai kon tell David, “Today, God don put yor enemy for yor hand. So make yu let mi shuk en head join groun. I nor nid to do am two times!”
1SA 26:9 But David ansa, “Nor kill-am! Na who go happy sey e kill di pesin wey God ensef choose?”
1SA 26:10 David still sey, “As God dey alive, na God go kill-am by ensef. One day e go sleep nor wake-up or dem go kill-am for war.
1SA 26:11 God forbid sey I kill di pesin wey E choose with en hand.” David kon tell Abishai, “Take en spear and en wota pot make wi komot from here!”
1SA 26:12 So David take di spear and di wota pot wey dey near Saul head and dem kon komot der. Nobody si dem or know sey dem kom or wake-up. All of dem don sleep go, bikos God don make betta sleep katch dem.
1SA 26:13 Den David cross go di oda side kon stand for far on-top di hill and betta gap dey between en and Saul.
1SA 26:14 E shaut give Abner wey bi Ner pikin, “Abner! Yu nor won ansa?” Abner kon ansa, “Who bi yu wey dey shaut won wake di king?”
1SA 26:15 David kon tell Abner, “I tink sey yu bi man? Afta all, who rish yu for di whole Israel land? Wetin kon make yu nor fit guide yor king? One soja almost won kill yor oga di king.
1SA 26:16 Yu don fail for yor work. As long as God dey alive, una wey nor fit protet una oga wey God choose as king, dead body betta pass una. Naw make yu find di king spear and wota pot wey dey near en head!”
1SA 26:17 Wen Saul know sey na David, e kon sey, “David my pikin, na yor vois bi dat?” David ansa, “Yes! My oga di king, na my vois.”
1SA 26:18 David still sey, “Wetin make my oga di king dey porshu en savant? Wetin I do? Wish bad tin I do?
1SA 26:19 So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’
1SA 26:20 Naw my king, nor let dem kill mi for land wey nor bi God own, bikos sey yu dey look for ant like mi, just as pesin dey look for animal for bush.”
1SA 26:21 Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”
1SA 26:22 David ansa, “Di king spear dey here.” Make one of di savant cross kom take am.
1SA 26:23 “God dey reward doz wey dey honest and raitious. Even doh today God put yu for my hand, I nor go ever kill di pesin wey God use en own hand choose.
1SA 26:24 Just as I save yor life today, make God save mi from evry trobol and wahala!”
1SA 26:25 So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.” So David go en own way and Saul kon go back.
1SA 27:1 David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”
1SA 27:2 So David and en six hundred men kon cross go meet king Akish wey bi Maok for Gat pikin.
1SA 27:3 David, en six hundred men and dia family kon stay with king Akish for Gat. David get two wifes, Ahinoam from Jezrel and Abigail from Karmel wey bin dey marry Nabal before Nabal die.
1SA 27:4 Wen Saul hear sey David don run go Gat, e kon stop to porshu am.
1SA 27:5 David tell Akish, “If yu know sey I bi yor friend, make yu give mi one small town make I stay. Wetin go make yor savant dey follow yu stay di royal town?”
1SA 27:6 Dat day, Akish kon give David, Ziklag town. (Bikos of dat, na Judah kings get Ziklag kom rish today.)
1SA 27:7 Na one year and four monts David stay for Filistia pipol land.
1SA 27:8 Den David and en men kon go fight Geshur, Girz and Amalek pipol wey dey stay di land since. David kill dem from di town mout for Shur go rish Egypt.
1SA 27:9 Anywhere David attack, e dey kill evribody finish. E go take dia sheep, kattles, donkeys, kamels and all dia klot, den e go-go back go meet Akish.
1SA 27:10 Wen Akish ask, “Where yu go fight today?” David go sey, “Di Negev for Judah” or “Negev for Jeharmeel” or “Negev for Ken.”
1SA 27:11 David kill both man and woman, so dat nobody go-go ripot dem for Gat. Dis na wetin David do all di time wen e dey Filistia.
1SA 27:12 So Akish trust David, bikos e bilive for en mind sey, “Israel pipol really hate David. So from naw go, e go get to stay here kon serve mi forever.”
1SA 28:1 Afta some time, Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. So Akish kon tell David, “Hope yu know sey yu and yor men go follow mi go fight.”
1SA 28:2 David ansa, “If na so di kase bi, den yu go know wetin yor savant fit do!” Akish kon sey, “Den I go make yu my bodyguard from naw go.”
1SA 28:3 Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.
1SA 28:4 Filistia pipol gada kon kamp for Shunem. Saul gada all en sojas for Israel kon kamp for Gilboa.
1SA 28:5 Wen Saul si sey Filistia sojas plenty well-well, e kon dey fear.
1SA 28:6 So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.
1SA 28:7 So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.”
1SA 28:8 Saul dress so dat pipol nor go know sey na en den e kon go with two of en men. Wen dem rish where di woman dey for nite, e kon sey, “Abeg, make yu use yor pawa take koll di pesin spirit wey I go tell yu.”
1SA 28:9 Di woman ansa am, “Si! Yu know wetin Saul don do; e don porshu di pipol wey dey si vishon and doz wey dey do majik komot from di land. So why yu dey kom try mi, so dat dem go kill mi?”
1SA 28:10 But Saul kon use God take swear sey, “As long as God dey alive, nor-tin go happen to yu.”
1SA 28:11 So di woman ansa, “Na wish pesin name yu wont make I koll?” Saul ansa, “Na Samuel wey don die.”
1SA 28:12 Wen di woman si Samuel, di woman kon kry well-well sey, “Wetin make yu deceive mi? Yu bi Saul!”
1SA 28:13 Di king ansa, “Nor let fear katch yu. Wetin yu si?” Di woman ansa, “I dey si pesin wey bi like god dey kom out from groun!”
1SA 28:14 Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun.
1SA 28:15 Samuel kon tell Saul, “Wetin make yu dey disturb mi? Wetin make yu koll mi kom back?” Saul ansa, “I dey for big wahala! Filistia pipol dey fight mi and God nor dey ansa mi again. E nor dey listin to mi or tok to mi thru profet or dream. So I kon koll yu, so dat yu go tell mi wetin I go do.”
1SA 28:16 Samuel kon sey, “Wetin make yu dey ask mi naw wey God don turn from yu kon bi yor enemy?
1SA 28:17 God dey do wetin E tok. E don tear di kingdom from yor hand kon gi-am to David.
1SA 28:18 Since yu nor gri obey God and yu nor show en vexnashon to doz Amalek pipol, God don ponish yu today.
1SA 28:19 God go give yu and Israel pipol to Filistia pipol. Tumoro, both yu and yor sons go dey with mi. God go still give Israel sojas to Filistia pipol.”
1SA 28:20 Saul kon kwik-kwik sleep for groun for der and e kon dey fear, bikos of wetin Samuel tok. E nor get any pawa to waka again, bikos e nor chop anytin from morning go rish nite.
1SA 28:21 Wen di woman kom meet and si how Saul dey fear rish, di woman kon tell am, “Yor savant don do wetin yu ask am. I risk my life kon do wetin yu tell mi.
1SA 28:22 Naw, na yor turn to listin to yor savant. Make I give yu some bread make yu chop. Wen yu don get pawa again, yu fit dey go.”
1SA 28:23 But Saul sey, “I nor wont chop.” En savants and di woman beg am well-well, so e kon gri with dem. E get up from groun kon sidan for di bed.
1SA 28:24 Di woman kwik-kwik kill di small melu wey e get, take some flower, prepare am kon bake bread wey nor get yist.
1SA 28:25 E gi-am to Saul and en savants and dem kon chop. Den dem go back, dat same nite.
1SA 29:1 Filistia pipol gada dia sojas for Afek, while Israel pipol kamp for Jezrel wotaside.
1SA 29:2 Filistia pipol leaders mash kom out with dia many-many sojas; so David and en men kon mash out with King Akish.
1SA 29:3 Filistia pipol kommander si dem kon ask, “Wetin dis Hibru dey do for here?” Akish kon ansa, “Dis na David, King Saul savant and e don dey with mi for sometaim naw. E neva do anytin wey go make mi blame am since e don dey with mi.”
1SA 29:4 But Filistia pipol kommander kon dey vex with King Akish, den di oga sey, “Tell dem make dem dey go! Make David and en men go back to di place wey yu gi-am. Nor let am follow us go fight, bikos e fit turn against us for di fight. Wetin e go do take win en oga favor back, dan make e turn kon bigin kill awa own men?
1SA 29:5 Abi nor bi dis David make dem dey sing and dance sey, “ ‘Saul kill 1,000, but David kill tazon plus tazon?’ ”
1SA 29:6 So Akish kon tell David, “I swear with God wey nor dey die sey, yu dey loyal to mi and na mi go happy pass sey yu follow mi go fight dis fight. I nor si anytin wey go let mi blame yu since di first day wey yu dey with mi kon rish naw. But di oda leaders bilive sey yu dey pritend.
1SA 29:7 So make peace dey with yu as yu dey go back to yor house and make yu nor do anytin wey go make di remainin Filistia leaders vex for yu.”
1SA 29:8 David kon ansa, “Oga! Wetin I do wey dey bad? If as yu tok sey I neva do yu any bad tin since di day wen I start to serve yu, wetin make mi nor fit follow yu wey bi my oga and king go fight yor enemies?”
1SA 29:9 Akish ansa, “I agri before and I si as yu loyal to mi like angel wey loyal to God. But di oda kings sey yu nor fit go fight with us.
1SA 29:10 So, tumoro, yu and yor men wey leave Saul kon meet mi, must get up go for morning wen day neva break well-well.”
1SA 29:11 So David and en men get up for early morning kon go back to Filistia, but Filistia sojas kon go Jezrel.
1SA 30:1 For di third day, David and en men kon rish Ziklag. But Amalek pipol attack Negev and Ziklag. Dem burn Ziklag rish groun.
1SA 30:2 Dem katch di wimen wey dey der, from di small ones go rish di old ones, but dem nor kill anybody. Dem just karry dem follow body.
1SA 30:3 Wen David and en men rish di town, dem kon si sey Amalek pipol don burn am kon karry dia wimen, sons and dotas go.
1SA 30:4 Den David and en men kon kry well-well until dem nor fit kry again.
1SA 30:5 Dem katch David two wifes, Ahinoam wey kom from Jezrel and Abigail from Karmel wey bi Nabal wife before.
1SA 30:6 David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.
1SA 30:7 Den David tell priest Abiatar wey bi Ahimelek pikin, “Bring di efod kon give mi.” So Abiatar bring di efod kom.
1SA 30:8 So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?” God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”
1SA 30:9 So David porshu dem with en six hundred men. Wen David rish River Besor, some of en men kon stay der.
1SA 30:10 David and 400 men kon kontinue to porshu dem and two hundred men wey don taya well-well kon stay for River Besor.
1SA 30:11 Den dem si one Egypt man for di field wey almost dey faint, so dem kon bring am kom meet David. Dem gi-am bread and wota make e chop and drink kon still gi-am
1SA 30:12 some fig wey don dry and two raisin. Dis food kon make am strong well-well, bikos e neva chop food or drink wota for three days and three nites.
1SA 30:13 David kon tell am, “Na who yu bi and where yu from kom?” Di yong man kon ansa, “I kom from Egypt and my oga na Amalek pesin. My oga go leave mi, bikos I dey sick for three days naw.
1SA 30:14 Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”
1SA 30:15 David kon tell am, “Yu fit take us go where yor pipol dey?” Di man ansa, “Make yu swear first sey yu nor go kill mi or give mi to my oga, den I go take una go der.”
1SA 30:16 So di man take David go where Amalek pipol dey and David kon si sey dem full di land. Dem dey chop and drink; dey enjoy diasef, bikos of evritin wey dem karry from Filistia pipol and Judah land.
1SA 30:17 But David kill dem from morning until di next evening. Non of dem eskape, escept di 400 men wey enter kamel kon run.
1SA 30:18 David kollect evritin wey Amalek pipol take before; e save en two wifes.
1SA 30:19 Nor-tin lost, weda na small or big tin. E save pipol sons and dotas; di tins wey Amalek pipol take from dem and evry oda tin wey dem take before. David bring evritin kom back.
1SA 30:20 David take all di sheep kon put dem for di oda animals front. Pipol kon dey sey, “Dis na di tins wey David karry!”
1SA 30:21 Naw, David don near di two hundred men wey don taya well-well to follow am go; doz wey dem live for River Besor. Dem kon go meet David and di pipol wey dey with am. Wen David rish where di two hundred men dey, e kon ask dem, “How una body!”
1SA 30:22 But all di wiked men among di ones wey follow David kon sey, “Since dem nor follow us go, wi nor go give dem anytin from di tins wey wi karry so. Make dem take only dia wifes and shidren dey go!”
1SA 30:23 But David sey, “Nor bi so, my brodas! Make una nor do like dis. Si wetin God don give us! E don protet and save us from Amalek pipol wey kom fight against us.
1SA 30:24 Who go listin to una for dis matter? Di tins wey dem give doz wey go fight di war, na di same tin dem go give dis men. Make evribody share am ekwol.”
1SA 30:25 David make dis law and Israel pipol dey obey dis law kon rish today.
1SA 30:26 Wen David go back to Ziklag, e kon send some of di tins wey dem karry, go give di leaders for Judah wey bi en friends sey, “Dis gift na for una, wi take dem from God enemies.”
1SA 30:27 Di gift na for di pipol wey dey: Bethel, Ramot Negev and Jattir;
1SA 30:28 doz wey dey Aroer, Sifmot, Eshtemoa,
1SA 30:29 and Rakal. Doz wey dey Jerahmeel and Ken town;
1SA 30:30 plus Hormah, Bor-Ashan, Atak,
1SA 30:31 Hebron and doz wey dey di oda arias wey David and en men don travel pass before.
1SA 31:1 Naw, Filistia sojas dey fight Israel sojas. Di men for Israel run from Filistia sojas and many of dem die for Mount Gilboa.
1SA 31:2 Filistia sojas kon katch and kill Saul three sons wey bi Jonatan, Abinadab and Malki-Shua.
1SA 31:3 Saul ensef even dey where di war for strong pass and dem kon shot am with arrow and di wound bad well-well.
1SA 31:4 So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef.
1SA 31:5 Wen di savant si sey Saul don die, en too kon take en own swod take kill ensef.
1SA 31:6 So Saul, en three sons, en savant and all en men kon die dat day.
1SA 31:7 Wen Israel men wey dey di valley and di oda side for Jordan River si sey all Israel men don die and Saul and en shidren don die too, dem kon run komot di town. So Filistia sojas kom take-ova di town.
1SA 31:8 Di next day, as Filistia sojas dey kollect tins from di dead body dem, dem kon si sey Saul and en three sons don die for Mount Gilboa.
1SA 31:9 Dem kut Saul head komot kon take en tins. Dem kon send pesin make e go tell evribody for dia juju temple and among dia pipol sey Saul and en shidren don die.
1SA 31:10 Dem put Saul swod for Ashtoret temple kon hang en body for Bet-Shan wey bi di town wall.
1SA 31:11 Wen Jabesh for Gilead pipol hear wetin Filistia pipol do with Saul body,
1SA 31:12 all dia sojas kon travel for nite go der. Dem karry Saul and en sons dead body from di town wall kon go back to Jabesh where dem for beri dem.
1SA 31:13 Dem take di bones kon beri dem under di tamarisk tree for Jabesh; den dem kon fast for seven days.
2SA 1:1 Afta Saul don die, wen David dey kom back from where e go fight and win Amalek pipol, e kon go stay Ziklag for two days.
2SA 1:2 For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.
2SA 1:3 David ask am, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I eskape from Israel pipol kamp.”
2SA 1:4 David kon sey, “Make yu tell mi wetin dey happen.” Di man ansa, “Awa sojas run komot from di war and dem kon kill many of awa pipol. Dem still kill Saul and Jonatan, en pikin.”
2SA 1:5 David ask am, “How yu take know sey Saul and Jonatan don die?”
2SA 1:6 E ansa, “Na from Mount Gilboa I from si Saul as e knee down with en spear and I si sey di enemy shariot and doz wey dey ride dem don dey near am well-well.
2SA 1:7 Den e turn round and wen e si mi, e kon koll mi. I ansa, ‘Yes sir!’
2SA 1:8 “E kon ask who I bi and I tell am sey, I bi Amalek pesin.
2SA 1:9 “Den e sey, ‘Kom kill mi! Dem don wound mi well-well and I dey die.’
2SA 1:10 “So I kon go kill-am, bikos I know sey e go die. Den I komot di crown from en head and di shain from en hand. So my oga, I don bring dem kom give yu.”
2SA 1:11 David and all en men kon vex tear dia klot.
2SA 1:12 Dem mourn, kry and fast till evening for Saul, Jonatan and for God pipol wey dey Israel, bikos dem don kill many of dem for war.
2SA 1:13 David kon ask di man wey kom tell am di news, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I bi Amalek pesin, but na yor kountry I dey stay.”
2SA 1:14 David ask am, “Wetin make yu nor fear to kill di pesin wey God choose?”
2SA 1:15 Den David kon tell one of en men, “Make yu kill-am!” Di man kon kill di Amalek man,
2SA 1:16 den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”
2SA 1:17 David sing dis song as e dey kry for Saul and Jonatan
2SA 1:18 and e sey make dem tish di song to pipol wey dey Judah. (Dem rite di song for Jashar book.)
2SA 1:19 “Awa leaders die on-top hill for Israel! Awa sojas wey strong pass don die!
2SA 1:20 Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.
2SA 1:21 Make rain or dew nor fall for Mount Gilboa, make di fields nor produce fruit at-all! Bikos na for der dem for disgrace strong sojas with all di pawa wey dem get. Dem abandon Saul shield wey e take dey protet ensef and dem nor rub oil put.
2SA 1:22 Jonatan arrow nor stop to flow with pipol blood; e even skata strong wariors flesh. Saul swod nor taya to distroy many pipol for groun.
2SA 1:23 I love Saul and Jonatan well-well. Deat nor go fit separate dem. Dem fast pass eagle and strong pass lion.
2SA 1:24 Israel wimen, make una mourn for Saul! E dey give una fine klot, jewel and gold.
2SA 1:25 Di sojas wey strong well-well don fall, dem kill dem for war; naw, Jonatan don die for di hill.
2SA 1:26 Jonatan my broda, si as I dey kry for yu! I love yu with all my heart, bikos di love wey yu get for mi, deep pass di one wey dem dey love woman.
2SA 1:27 Di sojas wey strong well-well don fall and naw, dia weapons don dey yuzles.”
2SA 2:1 Afta dis, David ask God, “Make I go stay one town for Judah?” God ansa am, “Yes! Yu fit go.” David ask again, “Na wish one?” God ansa, “Na Hebron.”
2SA 2:2 So David go Hebron with en two wifes, Ahinoam wey kom from Jezrel and Abigail from Karmel wey bi Nabal wife before.
2SA 2:3 E still karry en men and family go stay for di towns wey dey near Hebron.
2SA 2:4 Den Judah men kom Hebron kon make David king for Judah. Wen David hear sey Jabesh pipol wey dey for Gilead don beri Saul,
2SA 2:5 e kon send some men go tell dem sey, “Make God bless una as una take honor una king kon beri am.
2SA 2:6 Make God dey kind and faithful to una. Misef go trit una well bikos of wetin una do so.
2SA 2:7 Make una get heart, dey strong, bikos Saul wey bi una king don die and Judah pipol don make mi dia king.”
2SA 2:8 Abner wey bi Ner pikin and Saul soja oga, run with Saul pikin wey dem dey koll Ish-Boshet cross Jordan River go Mahanaim.
2SA 2:9 Na for der Abner for make Ish-Boshet king for Gilead, Asher, Jezrel, Efraim, Benjamin and all Israel aria.
2SA 2:10 E bi forty years wen dem make am king for Israel and e rule for two years. But Judah tribe, na David dem dey respet
2SA 2:11 and e rule Judah from Hebron for seven and half years.
2SA 2:12 Abner and di ofisas wey Ish-Boshet get kon komot from Mahanaim go Gibeon town.
2SA 2:13 Joab wey en mama name na Zeruaya and David ofisas kon meet demsef for di pool for Gibeon. All of dem sidan; one set dey for one side for di pool and di oda set dey for di oda side.
2SA 2:14 Abner kon tell Joab, “Make wi let some boys from di two side fight face-to-face.” Joab kon ansa, “Okay.”
2SA 2:15 So twelf men from Ish-Boshet and Benjamin tribe kon fight twelf men for David side.
2SA 2:16 All of dem kut demsef for head, use swod shuk each oda for belle and di twenty-four men fall for groun die togeda. So dem koll dat place for Gibeon, “Swod Field.”
2SA 2:17 Dat day, di fight kon strong well-well and David men win Abner and Israel pipol.
2SA 2:18 Zeruaya three sons dey der wey bi, Joab, Abishai and Asahel. Asahel dey run fast-fast like deer for bush, so
2SA 2:19 e kon dey porshu Abner,
2SA 2:20 Abner look back kon sey, “Asahel! Na yu bi dat?” Asahel ansa, “Yes! Na mi.”
2SA 2:21 Abner kon sey, “Make yu stop to porshu mi, but run follow one of di sojas make yu kollect wetin e get.” But Asahel nor gri.
2SA 2:22 Abner kon tell am again, “Make yu stop to porshu mi! Why yu won force mi to kill yu? How I go take face Joab, yor broda?”
2SA 2:23 But Asahel nor still stop, so Abner kon trow en swod go back and e enter en belle kon kom out for en back. So Asahel fall for groun die and evribody wey rish der, kon stand dey look am.
2SA 2:24 But Joab and Abishai bigin porshu Abner from evening till dem rish Ammah hill, near Giaya wey dey east for di side wey dey di road wey dem dey pass go Gibeon wildaness.
2SA 2:25 Di men wey kom from Benjamin tribe kon gada round Abner on-top di hill.
2SA 2:26 Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”
2SA 2:27 Joab ansa, “I use Oga God name take swear sey, if to sey yu nor tok, my men for porshu yu rish tumoro morning.”
2SA 2:28 Den Joab blow di trumpet to take signal en men make dem stop to porshu Israel pipol. So, di fight kon stop.
2SA 2:29 Abner and en men mash pass Jordan River Valley for nite kon cross and di next morning, dem kon rish Mahanaim.
2SA 2:30 Wen Joab stop to porshu dem, e gada all en men kon si sey na nineteen of dem, with Asahel en broda, naim die.
2SA 2:31 David men kill three hundred and sixty among Abner men wey kom from Benjamin tribe.
2SA 2:32 Dem take Asahel body kon go beri am for en papa grave for Betlehem. Den Joab and en men travel for dat nite and dem kon rish Hebron di next day.
2SA 3:1 Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.
2SA 3:2 Di shidren wey dem born for David for Hebron na: Amnon, wey en mama na Ahinoam, wey kom from Jezrel;
2SA 3:3 Kileab wey en mama na Abigail wey bi Nabal wife before and e kom from Karmel; Absalom wey en mama name na Maaka, wey bi King Talmai girl pikin for Geshur;
2SA 3:4 Adonijah, wey en mama name na Haggit; Shefataya wey en mama name na Abital;
2SA 3:5 Itream, wey en mama name na Eglah. Dem born all dis shidren give David for Hebron.
2SA 3:6 As David men and Saul men kontinue to dey fight, Abner kon popula and get pawa well-well for Saul pipol side.
2SA 3:7 One day, Ish-Boshet wey bi Saul pikin kon sey Abner dey sleep with Rizpah wey bi Aiaya pikin wey bi Saul girl-friend.
2SA 3:8 Di tin make Abner vex well-well and e kon sey, “Yu tink sey I go betray Saul? Yu tink sey na Judah I dey serve? I always dey respet Saul wey bi yor papa, en broda and en friend and I make sure sey David nor win una. But today, yu sey I dey sleep with yor papa girl-friend!
2SA 3:9 Make God ponish mi Abner, If I nor help David get wetin Oga God don promise am.
2SA 3:10 God go take di kingdom from Saul and en shidren-shidren kon make David king ova Judah and Israel pipol go rish Dan and Beersheba.
2SA 3:11 Ish-Boshet kon dey fear Abner sotey, e nor fit tok one word.”
2SA 3:12 Abner kon send messenjas go meet David wey dey Hebron dat time sey, “Who go rule dis land? Make yu make agriment with mi and I go bring Israel pipol kom yor side.”
2SA 3:13 David ansa, “Okay! I go make agriment with yu for one kondishon; yu must bring Mikal wey bi Saul dota, anytime wen yu dey kom meet mi.”
2SA 3:14 David still send messenjas go meet Ish-Boshet sey, “Make yu give mi my wife Mikal back, bikos I pay one hundred Filistia pipol skin to take marry am.”
2SA 3:15 So Ish-Boshet kollect am from Paltiel wey bi Laish pikin.
2SA 3:16 Paltiel kry follow am go rish Bahurim town. But Abner sey, “Make yu dey go yor house.” So e kon go.
2SA 3:17 Abner go meet di leaders for Israel kon tell dem, “E don tey wen una wont make David bi una king.
2SA 3:18 Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”
2SA 3:19 Abner still tok to Benjamin tribe kon go Hebron go tell David wetin Benjamin and Israel pipol agri to do.
2SA 3:20 Wen Abner with twenty men kom meet David for Hebron, David do party for dem.
2SA 3:21 Abner tell David, “My king, I go-go win Israel pipol kom give yu. Dem go take yu as king, den yu go get wetin yu dey find and yu go rule di whole land.” David kon make Abner know sey e dey save and e tell am make e dey go.
2SA 3:22 Naw Joab and David ofisas dey kom back from fight with many tins wey dem karry. Abner nor dey Hebron with David again, bikos David don tell am make e dey go, sey e dey save.
2SA 3:23 Wen Joab and en men kom, dem tell am sey Abner kom meet David and e tell am make e dey go sey e dey save.
2SA 3:24 So Joab go meet di king kon tell am, “Wetin yu do so? Abner kom meet yu, why yu let am go like dat?”
2SA 3:25 “Yu know sey, e kom here kon deceive yu and to know evritin wey yu dey do and anywhere wey yu dey go?”
2SA 3:26 Wen Joab leave David, e send messenja go koll Abner and dem bring am back from Sirah well, but David nor know anytin about am.
2SA 3:27 Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
2SA 3:28 Wen David hear wetin happen, e sey, “God know sey mi and my men hand nor dey Abner deat.
2SA 3:29 But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”
2SA 3:30 Na so Joab and Abishai wey bi en broda take kill Abner, bikos e kill Asahel dia broda for war for Gibeon.
2SA 3:31 Den, David orda Joab and en men sey make dem tear dia klot kon wear sak klot take mourn for Abner. King David follow Abner koffin for back wen dem dey go beri am.
2SA 3:32 Na for Hebron dem beri Abner and di king with all di pipol kon dey kry for en grave.
2SA 3:33 David sing dis song for Abner: “Why Abner go die like fool?
2SA 3:34 Dem nor tie en hands and legs, but e die like pesin wey tif kill!” All di pipol kon kry for am again.
2SA 3:35 For morning go rish evening for dat day, di pipol try taya make David for chop sometin, but David don promise sey, “Make God ponish mi, if I chop anytin today!”
2SA 3:36 Dem si wetin David do and all of dem happy well-well. Di pipol like evritin wey David do.
2SA 3:37 All di pipol for Israel and David pipol kon undastand sey, en hand nor dey for Abner deat.
2SA 3:38 Di king tell en ofisas, “Una nor si sey one big leader die komot for Israel today?
2SA 3:39 Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”
2SA 4:1 Wen Saul pikin, Ish-Boshet hear sey dem don kill Abner for Hebron, fear katch am well-well and dem kon tell evribody for Israel.
2SA 4:2 Ish-Boshet get two ofisas; Baanah and Rekab wey bi leaders for war and dia papa na Rimmon from Beerot wey dey Benjamin tribe.
2SA 4:3 Di pipol wey get dat land don run go Gittaim and dem don dey stay der since.
2SA 4:4 Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin, na five years e bi wen di news kom from Jezrel sey dem don kill en grand-papa Saul and Jonatan en papa for war. Den en nurse kon karry am dey run, but bikos e dey hurry, di pikin fall from en hand, so en leg kon break.
2SA 4:5 Rekab and Baanah go Ish-Boshet house for aftanoon wen e dey rest.
2SA 4:6 Di pesin wey dey di door don sleep go as e dey pick dirty komot for wheat, so Rekab and Baanah kon waka small-small enter di house.
2SA 4:7 At wons, dem enter Ish-Boshet room kon kill-am. Den dem kut en head, karry follow body kon waka for nite pass Jordan River Valley.
2SA 4:8 Dem give di head to David for Hebron kon sey, “Ish-Boshet wey bi Saul pikin; yor enemy wey won kill yu, na en head bi dis. Today, God don allow di king revensh Saul and en shidren-shidren.”
2SA 4:9 David kon ansa dem, “As long as di God wey save mi from all danger dey alive,
2SA 4:10 even di messenja wey kom meet and tell mi for Ziklag sey Saul don die tink sey e dey bring good news kom give mi. I whole and I kill-am. Dat na di reward wey I gi-am for en good news!
2SA 4:11 Not to tok about una wey do evil kon go kill pesin wey dey sleep for en own house! I go take revensh and as una kill-am, na so una go take die too!”
2SA 4:12 Den David orda en sojas and dem kill dem. Dem kut dia hand and leg komot kon hang dem near Hebron wotaside. But dem take Ish-Boshet head kon go beri am for Abner grave for Hebron.
2SA 5:1 Den all di tribes go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood.
2SA 5:2 Before-before wen Saul still bi awa king, yu lead Israel pipol for war and God promise yu sey yu go rule en pipol and bi dia king.”
2SA 5:3 Wen all di leaders for Israel meet King David for Hebron, David setol with dem and dem kon make am king for Israel.
2SA 5:4 David na thirty years wen e bikom king and e rule for forty years.
2SA 5:5 E rule Judah pipol from Hebron for seven and half years; e rule Israel pipol for Jerusalem and Judah for thirty-three years.
2SA 5:6 Time kon rish for David and en men to attack Jerusalem. Jebus pipol wey dey der, tink sey David nor go fit win di town. So dem tell David, “Yu nor go fit enter here, even blind pipol and cripple, go fit win yu.”
2SA 5:7 But David win Zion take and dem kon dey koll am, “David Town.”
2SA 5:8 David ask en men dat day, “E get anybody for here wey hate Jebus pipol rish mi? Make wi kill dem? Den, make una pass di wota go kill doz poor and blind cripple.” Na dis make dem sey, “Doz wey dey blind and cripple, nor fit enter God house.”
2SA 5:9 Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.
2SA 5:10 David kon dey strong evriday, bikos Oga God wey dey mighty, dey with am.
2SA 5:11 King Hiram for Tyre kon send business men go meet David, e send cedar woods with karpenters and doz wey dey do stones go meet David make dem take build di palis.
2SA 5:12 So, David kon know sey God don make am king for Israel and E dey make en kingdom prosper, bikos of en pipol.
2SA 5:13 Wen David don komot from Hebron go Jerusalem, e kon get many wifes, girl-friends and shidren.
2SA 5:14 Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon,
2SA 5:15 Ibhar, Elishua, Nefeg, Jafia,
2SA 5:16 Elishama, Eliada and Elifelet.
2SA 5:17 Dem tell Filistia pipol sey dem don make David king for Israel, so dia sojas kon ready to go fight am. Wen David hear am, e kon go di aria wey dey save.
2SA 5:18 Filistia pipol kamp for Refah Valley.
2SA 5:19 David kon ask God, “Make I attack Filistia pipol? Yu go help mi win dem?” God ansa, “Yes! Make yu attack dem! I go give yu viktory!”
2SA 5:20 So David go Baal-Perazim and e win Filistia pipol for der. E sey, “God don break-pass my enemies like flood.” So dem kon koll di place, Baal-Perazim.
2SA 5:21 Wen Filistia pipol dey run, dem run leave dia juju and David and en men kon karry dem komot.
2SA 5:22 Filistia pipol kon go Refah Valley go stay again.
2SA 5:23 David ask God again and E ansa, “Nor attack dem from here, but go round make yu ready to attack dem from di oda side near where Balsam trees dey.
2SA 5:24 Wen yu hear mashin sound on-top di trees, make yu attack, bikos I go mash go front go win Filistia sojas for yu.”
2SA 5:25 David do wetin God kommand and e drive Filistia pipol from Gibeah go rish Geza.
2SA 6:1 David gada 30,000 sojas for Israel wey sabi fight well-well
2SA 6:2 kon lead dem go Baala for Judah make dem go bring di Kovenant Box wey karry God name, wey en throne big pass di creature wey get feadas.
2SA 6:3 Dem karry am komot from Abinadab house for di hill kon go put am for one new truck wey melu dey draw. Uzza and Ahio, wey Abinadab born, na dem dey guide di truck.
2SA 6:4 Ahio dey waka for di box front.
2SA 6:5 David and Israel pipol sing and dance well-well to take honor God. Dem dey play harp, jita, drums, sheke-sheke and cymbals.
2SA 6:6 Wen dem waka rish Nakon farm, di animal wey karry di box bin won fall and Uzza try to hold am make e nor for fall.
2SA 6:7 At wons, God vex well-well for Uzza kon kill-am, bikos e nor respet God and Uzza die near di box.
2SA 6:8 So, na Perez Uzzah dem dey koll dat place kon rish naw. David vex bikos God use vexnashon take ponish Uzza.
2SA 6:9 Den, David fear God well-well kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box follow body naw?”
2SA 6:10 So David kon sey e nor go karry am go Jerusalem again, den e turn kon karry am go Obed-Edom house. Na Gat Obed-Edom from kom.
2SA 6:11 Di box stay der for three mont and God kon bless Obed-Edom and en family.
2SA 6:12 David hear sey God don bless Obed-Edom family and evritin wey e get, so e kon karry di Kovenant Box komot from Obed-Edom house go Jerusalem as dem dey celebrate.
2SA 6:13 Wen di men wey karry di box don waka six steps, David stop dem kon sakrifice two (man and woman) big melu give God.
2SA 6:14 David wey wear only linen for en waist, dance well-well to take honor God.
2SA 6:15 En and Israel pipol blow trumpet kon dey shaut as dem dey karry di box with happiness go Jerusalem.
2SA 6:16 As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.
2SA 6:17 Dem bring di box kon put am for di place wey David make for am for di tent. Den e give God sakrifice and fellowship ofrins.
2SA 6:18 Wen e don give di sakrifice finish, e bless di pipol with God name
2SA 6:19 kon give dem food. David kon give bread, rice and meat wey dem roast to evribody for Israel, den all of dem kon go dia house.
2SA 6:20 Afta, wen David go greet en family for house, Mikal kom meet and tell David for outside sey, “Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef for en girls savant and ofisas front!”
2SA 6:21 David ansa, “I dey dance to honor God wey choose mi, instead of yor papa and en family. E make mi lead Israel wey bi en pipol. I go kontinue to dey respet God with my dance
2SA 6:22 and I go disgrace mysef pass like dis. Yu fit tink sey I fool mysef for pipol front, but doz girls go respet mi more-more!”
2SA 6:23 Bikos of dis tin, Mikal wey bi Saul pikin, nor born any pikin till e die.
2SA 7:1 Den King David kon go stay en house. And God keep am save from en enemies.
2SA 7:2 One day, e koll Profet Natan kon sey, “I dey stay dis house wey dem build with cedar, but God Kovenant Box, dey for tent!”
2SA 7:3 Natan ansa, “Make yu do wetin dey yor mind, bikos God dey with yu.”
2SA 7:4 But dat nite, God kon tell Profet Natan,
2SA 7:5 “Make yu go tell David wey bi my savant sey, ‘Nor bi yu go build temple for mi wey I go stay.
2SA 7:6 From di time wey I save Israel pipol from Egypt till naw, I neva stay for temple; na only tent I dey stay and I dey waka from one place to anoda.
2SA 7:7 As I dey follow Israel pipol travel rish, I neva tell any leader wey I choose before sey make e use cedar build temple for mi.’
2SA 7:8 So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol.
2SA 7:9 I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.
2SA 7:10 I don choose place for my pipol Israel and I don put dem for where dem go stay and nobody go opress dem again.
2SA 7:11 Bad pipol dey opress dem since dem kom dis land, but e nor go happen again. I promise sey, I go make yu win all yor enemies and I go give yu many shidren.
2SA 7:12 Wen yu die and yu don go join yor grand-grand papa, I go make one among yor shidren king and I go make en kingdom strong.
2SA 7:13 Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom go dey forever.
2SA 7:14 I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin.
2SA 7:15 I nor go take my love and favor from am just as I take am from Saul, wey I remove so dat David go bi king.
2SA 7:16 En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”
2SA 7:17 Profet Natan tell David evritin wey God show am.
2SA 7:18 Den David enter Tabanako sidan kon bigin pray sey, “My Oga God! Mi and my family nor rish who Yu go do all dis good tins for.
2SA 7:19 But Yu dey even do di ones wey pass dem. Yu don promise my shidren-shidren tins for many years wey dey kom and Yu, Oga God don let mi si dis tins.
2SA 7:20 Wetin I go tell Yu again? Yu know mi well-well, but Yu still dey respet mi wey bi yor savant.
2SA 7:21 Bikos of yor promise and as Yu wont am, na-im Yu take do dis tins kon show mi wey bi yor savant.
2SA 7:22 Oga God! Yu dey great! Nobody bi like Yu. Na only Yu bi God. Wetin wi don hear, na true!
2SA 7:23 No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der.
2SA 7:24 Yu don make Israel pipol yor own forever and Yu, my Oga, don bi dia God.
2SA 7:25 Naw, my Oga God, make Yu do wetin Yu promise my shidren-shidren and wetin Yu sey Yu go do.
2SA 7:26 Dem go know yor name and pipol go tok forever sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always dey protet my kingdom.
2SA 7:27 Oga God Almighty wey bi Israel pipol God! I dey pray dis prayer with all my heart, bikos Yu don show mi yor savant, all dis tins kon promise mi sey, ‘Yu go make my shidren-shidren king forever.’
2SA 7:28 Oga God wey get pawa, Yu bi God and Yu dey always do wetin Yu promise.
2SA 7:29 I sey make Yu bless my shidren-shidren; make dem enjoy yor favor forever. God wey get pawa, don promise dis tin and yor blessing go dey with my shidren forever.”
2SA 8:1 Afta sometaim, King David attack Filistia pipol again, e win dem kon take dia land wey bi Meteg Ammah from dia hand.
2SA 8:2 E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.
2SA 8:3 David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria.
2SA 8:4 David seize 1,000 seven hundred horse-men and 20,000 sojas wey dey waka for groun. E keep like one hundred horse kon cripple di rest.
2SA 8:5 Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help Hadadeza, David attack and kill 22,000 of dem.
2SA 8:6 Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.
2SA 8:7 Di gold shield wey Hadadeza take dey guide ensef, David karry am go Jerusalem.
2SA 8:8 E still take plenty bronze from Tebah and Berotai towns wey Hadadeza dey rule.
2SA 8:9 King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas.
2SA 8:10 So e send Joram en pikin make e go kongratulate David for en viktory against Hadadeza wey King Toi don fight many times.
2SA 8:11 David dedikate di silva and gold wey e bring from di nashons wey e win and dem use dem take serve God.
2SA 8:12 E win Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol and e still karry tins from Hadadeza.
2SA 8:13 David kon popula well-well afta e just kom back from where e for go kill 18,000 Edom pipol for Salt Valley.
2SA 8:14 E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.
2SA 8:15 David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind.
2SA 8:16 Joab wey en mama name na Zeruaya, naim dey kommand di sojas, while Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep rekord.
2SA 8:17 Zadok wey bi Ahitub pikin and Ahimelek wey bi Abiatar pikin, na dem bi priests. Na Seraya bi di kourt seketry.
2SA 8:18 Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim bi David bodyguard oga. David sons na priests too.
2SA 9:1 One day, David ask, “E get anybody wey remain for Saul family? If e dey, I go like do good for am, bikos of Jonatan.”
2SA 9:2 E get one savant for Saul family wey dem dey koll Ziba and dem tell am make e go meet David. David kon ask am, “Na yu bi Ziba?” E ansa, “Yes sir! I bi yor savant.”
2SA 9:3 David ask am, “E get anybody wey remain for Saul family wey I go show respet and dey kind to, just as I promise God sey I go do?” Ziba ansa, “E still get one Jonatan pikin wey remain, but e nor fit waka again.”
2SA 9:4 So David ask am, “Where e dey?” Ziba ansa, “E dey for Makir wey bi Ammiel pikin house for Lo-Debar.”
2SA 9:5 Den David sey make dem go bring am kom.
2SA 9:6 Wen Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin rish der, e show respet to David kon bow for en front. David koll am, “Mefiboshet!” E ansa, “My oga, I bi yor savant.”
2SA 9:7 David tell am, “Make yu nor fear. I go dey kind to yu, bikos of Jonatan wey bi yor papa. I go give yu evritin wey bi Saul, yor grand-papa own and anytime wey yu kom my tabol, I go welkom yu.”
2SA 9:8 Mefiboshet bow again kon sey, “Oga, I nor betta pass dog wey don die, why yu dey good to mi like dis?”
2SA 9:9 Di king koll Ziba wey bi Saul savant kon sey, “Evritin wey bilong to Saul and en family, I dey give dem to Mefiboshet wey bi yor oga grand-pikin.
2SA 9:10 Yu, yor shidren and yor savants go work for di land wey bi yor oga family own kon harvest and provide food for Mefiboshet family. But Mefiboshet ensef, go always kom chop for my tabol.” Ziba get fifteen shidren and twenty savant.
2SA 9:11 Ziba ansa, “I go do evritin wey my king kommand.” So Mefiboshet kon dey chop for di king tabol like sey e bi king pikin.
2SA 9:12 Mefiboshet get one son and en name na Mikah. All di pipol for Ziba family kon bi Mefiboshet savant.
2SA 9:13 So Mefiboshet wey nor fit waka kon dey stay for Jerusalem and dey chop for di king tabol.
2SA 10:1 Afta sometaim, King Nahash for Ammon kon die and en pikin, Hanun kon bi king.
2SA 10:2 King David sey, “I must go pay respet and make friend with Hanun, as Nahash wey bi en papa do to mi.” So David send messenjas go tell am, “Sorry!” Dis na bikos of en papa wey die. Wen dem rish King Hanun palis for Ammon,
2SA 10:3 doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kom? Wi bilive sey e send dem kom spy di land, so dat e go kom fight and win us leta!”
2SA 10:4 So, King Hanun seize David messenjas kon kut dia hair and klot, den e send dem go back.
2SA 10:5 Shame nor let di men go back to dia house. Wen David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko till dia hair go grow again.
2SA 10:6 Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.
2SA 10:7 Wen David hear wetin dey happen, e kon send Joab with all en sojas go fight dem.
2SA 10:8 Ammon sojas mash go pozishon for where dem dey pass enter Rabbah, wey bi dia kapital town and di kings wey kom help dem, pozishon put for di open field.
2SA 10:9 Wen Joab si sey dia enemy sojas go attack dem from front and back, e choose Israel sojas wey strong kon make dem face Siria sojas.
2SA 10:10 E kon sey make Abishai en broda dey kommand di oda sojas for di oda side wey face Ammon sojas.
2SA 10:11 Joab tell am, “If yu si sey Siria sojas dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon sojas dey opress yu I go kom help yu.
2SA 10:12 “Make yu get heart and dey strong! Make wi fight well for awa pipol and for God towns and make God do wetin dey en mind.”
2SA 10:13 Wen Joab with en sojas attack, Siria sojas kon bigin run.
2SA 10:14 So as Ammon sojas si sey Siria sojas dey run, dem too kon bigin run from Abishai enter di town. Den Joab kon go back to Jerusalem.
2SA 10:15 Siria pipol si as Israel pipol win dem, so dem kon go gada demsef again.
2SA 10:16 Hadadeza kon send for more Siria sojas wey dey di east side for Eufrates River and dem sey make Shobak wey dey kommand Hadadeza sojas for Zobah bi dia kommander.
2SA 10:17 Wen David hear wetin dey happen, e kon gada all Israel sojas, cross Jordan River kon put dem for di side wey face Siria, den di war kon start.
2SA 10:18 Israel sojas kon porshu Siria sojas go back. David with en men kill 7,000 war horse-men and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey dey kommand Siria sojas.
2SA 10:19 Wen di kings wey dey follow Hadadeza si sey Israel sojas don win dem well-well, dem kon go make peace with David and dey obey am. So, Siria pipol nor gri help Ammon pipol again.
2SA 11:1 Before dry sizin, for di time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipol sojas and dem defeat Ammon pipol kon take-ova Rabbah town. But David stay for Jerusalem.
2SA 11:2 One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.
2SA 11:3 So e send messenja go find out who di woman bi. Leta, dem kon tell am sey na Batsheba, wey bi Eliam pikin and na Uriaya wey bi Hit pesin, bi en husband.
2SA 11:4 David send messenjas go koll am. Dem koll di woman kom and David sleep with am. Dat time, di woman just mestrate finish, so e kon go en house back.
2SA 11:5 Afta, di woman kon si sey e get belle, den e send message go tell David.
2SA 11:6 David send message go give Joab, “Make yu send Uriaya wey bi Hit pesin kom meet mi.” So Joab send am go meet David.
2SA 11:7 Wen Uriaya kom, David ask weda evritin dey well with Joab and di rest pipol and how di fight dey go.
2SA 11:8 Den e tell Uriaya, “Make yu go house go rest small.” Uriaya go en house, den David send gift go gi-am.
2SA 11:9 But Uriaya nor go house, instead e sleep for di palis gate with di guards.
2SA 11:10 Wen David hear sey Uriaya nor go house, e kon ask am, “Yu just kom back from where yu go since, why yu nor go house?”
2SA 11:11 Uriaya ansa, “Israel and Judah men with di Kovenant Box dey war; Joab wey bi my kommander and en ofisas, kamp for open place. How I go take go house go chop, drink and sleep with my wife? So, I use evritin wey dey holy take swear sey I nor go fit do dat kind tin.”
2SA 11:12 So David ansa, “Make yu stay here today and tumoro, den I go send yu go back.” So Uriaya stay for Jerusalem dat day and di next day.
2SA 11:13 David invite am kom chop and drink till evening. But Uriaya nor still go house dat nite, instead e sleep for en blanket for di palis guard-room.
2SA 11:14 Di next day, David rite leta give Uriaya sey make e give Joab.
2SA 11:15 Wetin dey di leta na, “Put Uriaya for di front line, where di fight for strong well-well, so dat dem go kill-am.”
2SA 11:16 So, as Joab dey surround di town, e kon send Uriaya go di place where enemies for strong well-well.
2SA 11:17 Di enemy sojas kom fight Joab sojas and dem kill Uriaya with some of David ofisas.
2SA 11:18 Den Joab send messenja go tell David how di war dey go
2SA 11:19 and e tell di messenja sey, “Afta yu don tell di king about di war,
2SA 11:20 e fit vex ask yu, ‘Why una go near di town go fight dem? Una nor know sey dem go shot arrow from di walls?
2SA 11:21 Una don forget how dem take kill Abimelek wey bi Gideon pikin? Na for Tebez, one woman trow stone from di wall kon kill-am. Why una go near di wall like dat?’ If di king ask yu dis tins, den make yu tell am sey, ‘Uriaya wey bi yor offisa, don die too.’ ”
2SA 11:22 So di messenja go meet David kon tell am wetin Joab tok.
2SA 11:23 E sey, “Awa enemy strong pass us and dem from di town kom fight us for open field, but wi drive dem go di town gate back.
2SA 11:24 Den dem shot arrow from di wall kon kill Uriaya and some of yor ofisas.”
2SA 11:25 David tell di messenja, “Tell Joab make e nor fear or vex, bikos dem nor dey know who go die for war. Tell am make e attack di town well-well kon win am.”
2SA 11:26 Wen Batsheba hear sey dem don kill en husband, e mourn for am.
2SA 11:27 Wen e mourn finish, David kon bring am kom di palis and e born boy for am. But God nor like wetin David do.
2SA 12:1 God send Profet Natan go tell David, “E get two men wey dey stay for di same town; one get money and di oda one poor.
2SA 12:2 Di rish man get many melu and sheep
2SA 12:3 and di poor man get only one sheep wey e buy. E dey kare for am and di sheep grow for en house with en shidren. E dey gi-am wetin e dey chop; di sheep dey drink wota with di man cup kon sidan for di man leg. Di sheep bi like pikin to am.
2SA 12:4 “But one day, di rish man get visitor for en house. E nor won kill en own animal take kook for di visitor, instead e go take di poor man sheep take kook for dem.”
2SA 12:5 David vex for di rish man well-well kon sey, “I swear with God name, di man wey do dis tin, must die!
2SA 12:6 E must pay four times for di wiked tin wey e do.”
2SA 12:7 So Natan tell David, “Na yu bi di man and dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok. I make yu king for Israel and I save yu from Saul.
2SA 12:8 I give yu en wifes and kingdom; I make yu king for Judah and Israel. If dem nor rish for yu, I for still give yu many oda tins.
2SA 12:9 Wetin kon make yu disobey my kommand? Why yu do dis wiked tin? Yu kill Uriaya for war; yu allow Ammon sojas kill-am, den yu kon take en wife!
2SA 12:10 Naw, for evry generashon, yor shidren-shidren go die anyhow, bikos yu nor obey mi kon take Uriaya wife.
2SA 12:11 “I swear sey I go make somebody for yor family bring trobol kom give yu. Yu go si am wen I go kollect yor wife from yu kon gi-am to anoda man and e go sleep with dem for publik.
2SA 12:12 Yu sin for sekret, but I go make dis tin happen for publik make all Israel pipol si am.”
2SA 12:13 So David sey, “I don sin against God.” Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die.
2SA 12:14 But bikos yu show God sey yu dey sorry for wetin yu do, yor pikin go die.” Den Natan kon go en house.
2SA 12:15 God kon make di pikin wey Uriaya wife born for David sick well-well.
2SA 12:16 David pray to God make di pikin well. E nor gri chop anytin and evry nite, e go enter en room liedan for groun.
2SA 12:17 En ofisas for house go meet am make e for stand up, but e nor gri or chop anytin with dem.
2SA 12:18 Afta one week, di pikin kon die and fear nor let David ofisas tell am di news. Dem sey, “Wen di pikin dey life, David nor dey ansa us wen wi tok to am, na how wi go take tell am sey di pikin don die? E fit go wound ensef o-o!”
2SA 12:19 Wen David si sey dem dey tok to diasef, e kon feel sey di pikin don die. So e ask dem, “Di pikin don die?” Dem ansa, “Yes! E don die.”
2SA 12:20 So David stand up go baf; e komb en hair kon shange en klot. Den e go woship for God house. Wen e rish di palis, e ask for food and e chop am as dem just bring am.
2SA 12:21 En ofisas tell am, “Wi nor undastand dis tin! Wen di pikin dey live, yu kry for am and yu nor gri chop, but as e just die, yu get up go chop!”
2SA 12:22 David ansa, “Yes! I kry and fast wen e still dey live. I tink sey God go forgive mi, so dat di pikin nor go die.
2SA 12:23 But naw wen e don die, why I go dey fast? I go-go where e dey one day, but e nor fit kom meet mi for here again.”
2SA 12:24 Den David konfort Batsheba en wife. E sleep with am again and e born boy and David koll am Solomon. God love di pikin
2SA 12:25 and E kommand Profet Natan make e koll am Jedidaya, bikos God love am.
2SA 12:26 Joab still kontinue en fight against Rabbah wey bi di kapital town for Ammon and e don dey win am.
2SA 12:27 E send messenjas go meet David sey: “I don attack Rabbah and I don take-ova where en wota dey kom from.
2SA 12:28 Naw, make yu gada yor oda sojas kon attack di towns, den take am by yorsef. I nor wont make anybody praiz mi sey na mi win am.”
2SA 12:29 So David gada en sojas go attack Rabbah and e win am.
2SA 12:30 David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town.
2SA 12:31 David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.
2SA 13:1 King David pikin Absalom get one fine sista wey en name na Tamar. David get anoda pikin wey bi Amnon wey love Tamar well-well.
2SA 13:2 E love am well-well sotey e kon dey sick, bikos e nor dey possibol for am to sleep with Tamar. And bikos di girl na virgin, dem nor let am near any man.
2SA 13:3 Amnon get one wayo friend and en name na Jonadab and na David broda, Shimei born am.
2SA 13:4 Jonadab ask Amnon, “Wetin make di king pikin dey vex evry morning? Naw, make yu tell mi wetin dey happen?” Amnon ansa, “I love Tamar wey bi my half broda Absalom, sista.”
2SA 13:5 Jonadab tell am, “Make yu do like sey yu nor well kon go liedan for bed. If yor papa kom si yu, den yu go tell am sey, ‘Abeg, make yu tell Tamar my sista sey make e kom give mi food. I wont make e make di food for here where I go dey si am, den serve mi by ensef.’ ”
2SA 13:6 So Amnon do like sey e nor well kon go liedan for bed. Wen David go si am, e kon tell di king sey, “Abeg! Make yu tell Tamar make e kom bake kake for here make I dey si am, den serve mi by ensef.”
2SA 13:7 So David send message go meet Tamar for di palis sey, “Make yu go Amnon house go make food for am.”
2SA 13:8 Wen di girl go der, e si Amnon sleep for en bed, so e take flower kon bake kake for en front.
2SA 13:9 E remove di kake from di pan kon go give Amnon make e chop, but e nor gri chop, instead e sey, “Make evribody go outside,” den all of dem kon komot.
2SA 13:10 Den Amnon tell Tamar, “Bring di kake kom give mi for bed, den serve mi by yorsef.” So di girl karry di kake go where e dey.
2SA 13:11 As Tamar dey feed am, at wons Amnon drag am kon sey, “Make yu kom sleep with mi!”
2SA 13:12 Tamar ansa, “No! Make yu nor force mi do dat kind bad tin wey dey bring disgrace!
2SA 13:13 How I go take face pipol for publik again? Dem go disgrace yu for Israel too. So abeg, make yu go tell di king, I dey sure sey e go give mi to yu as yor wife.”
2SA 13:14 Amnon nor gri, but bikos e get pawa pass di girl, e kon force and sleep with am.
2SA 13:15 Afta Amnon don sleep with Tamar, e kon hate am pass di wey e love am before. Den e tell am, “Make yu get out komot here!”
2SA 13:16 Tamar kon ansa, “No! For yu to send mi go like dis, na dat crime big pass di one wey yu don kommit so!” But Amnon nor gri listin to am.
2SA 13:17 E koll en savant kon tell am, “Make yu porshu dis woman komot from where I dey! Go trow am outside, den lock my door!”
2SA 13:18 Di savant push Tamar go outside kon lock di door. Tamar wear one long gown wey kover evriwhere and wimen wey neva marry dat time, na dem dey wear am.
2SA 13:19 Den Tamar put shako for en head, tear en gown kon use en hand kover en face as e dey kry dey go.
2SA 13:20 Wen Absalom en broda si am, e kon ask, “My sista! Na true sey Amnon dey with yu since? Abeg, make yu nor let dat one vex yu too mush. Na yor half broda e bi, so nor tell anybody about am.” So Tamar stay for Absalom house kon dey vex.
2SA 13:21 Wen David hear wetin happen, e vex well-well.
2SA 13:22 But Absalom nor tell Amnon anytin, weda na good or bad, but e kon hate Amnon bikos of wetin e do to en sista Tamar.
2SA 13:23 Afta two years don pass, wen Absalom won kut hair komot from en sheep body for Baal-Hazor, wey dey near Efraim town, e kon invite all di king sons kom der.
2SA 13:24 E go meet David kon tell am, “My king, I won kut my sheep hair. Yu fit kom di party with yor ofisas?”
2SA 13:25 Di king ansa, “No my pikin, if wi kom, di wahala go too mush for yu.” Absalom still dey beg make di king kom, but e nor gri, instead e sey make Absalom dey go.
2SA 13:26 Absalom tell am, “Yu fit let Amnon, my broda kom?” Di king ansa, “Why yu wont make e kom?”
2SA 13:27 But Absalom kontinue to beg, till David kon gri make Amnon with en oda brodas go. Absalom prepare betta party for kings
2SA 13:28 kon tell en savants, “Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di orda, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!”
2SA 13:29 So en savants do wetin Absalom tok kon kill Amnon. David shidren wey remain kon klimb dia horse bigin run.
2SA 13:30 As dem dey road dey go house, news kon rish David sey, “Absalom don kill all en shidren and no one remain.”
2SA 13:31 Di king stand up, tear en klot kon use en body nak groun. All en savants wey dey der with am, still tear dia klot too.
2SA 13:32 But Jonadab wey bi David broda, Shimei pikin kon sey, “My king, dem neva kill all yor shidren, na only Amnon dem kill. Yu suppose know sey Absalom go kill-am, since di time wen e force and sleep with en sista Tamar.
2SA 13:33 So make yu nor bilive di news sey all yor shidren don die, na only Amnon dem kill.”
2SA 13:34 As dis tin happen, Absalom kon run. Dat time, one soja dey kom from work and e si many pipol dey kom from di hill for di road wey dem dey pass kom from Horonaim. So e go meet di king kon tell am wetin e si.
2SA 13:35 Jonadab tell David, “Just as I tell yu, na yor shidren dem dey kom so.”
2SA 13:36 As e just tok finish, David shidren kon enter inside. Dem bigin kry and David with all en ofisas kry well-well too.
2SA 13:37 Absalom run go meet Geshur king kon stay der with Talmai wey bi Ammihud pikin. But na evriday David for en son.
2SA 13:38 Afta Absalom run, e stay Geshur for three years.
2SA 13:39 But wen di king don forget about Amnon deat, e kon dey hongry to si Absalom again.
2SA 14:1 Joab know sey David won si Absalom,
2SA 14:2 so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since.
2SA 14:3 Den go meet di king kon tell am wetin I tell yu,” So, Joab tell am wetin e go tok.
2SA 14:4 Di woman wey kom from Tekoa town, go meet di king, bow kon sey, “My king! Make yu help mi!”
2SA 14:5 Di king ask am, “Wetin yu wont?” Di woman ansa, “Oga! I bi poor widow wey en husband don die.
2SA 14:6 I born two boys and dem kon dey kworel for farm and bikos nobody dey to hold dem, won kon kill di oda one.
2SA 14:7 And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”
2SA 14:8 So di king ansa, “Make yu dey go yor house and I go take kare of dis matter.”
2SA 14:9 Di woman wey kom from Tekoa kon sey, “My king! Anytin wey happen, make dem blame mi, bikos yu and yor royal family dey innocent.”
2SA 14:10 Di king ansa, “If anybody make yu fear, make yu bring am kom meet mi and e nor go disturb yu again.”
2SA 14:11 Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.” David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”
2SA 14:12 Di woman still sey, “I beg yu, my king! Make I tok anoda tin,” David ansa, “Okay.”
2SA 14:13 Di woman tell am, “Why yu do dat kind tin to God pipol? Yu neva let yor own pikin kom back from where e hide put since, so yu don kondemn yorsef with wetin yu just tok so.
2SA 14:14 One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
2SA 14:15 “Naw! My king, di tin wey make mi kom tok to yu bi sey di pipol dey treaten mi, so I tell mysef sey I go tok to yu and yu go do wetin I ask.
2SA 14:16 I know sey yu go listin to mi kon save mi from di pesin wey dey try to kill mi and my pikin, so dat dem go remove us from di land wey God give en pipol.
2SA 14:17 “Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
2SA 14:18 Di king ansa, “I won ask yu one kweshon and yu must tell mi di whole trut.” Di woman ansa, “My king, make yu ask.”
2SA 14:19 Di king ask, “Nor bi Joab send yu kom? “Di woman ansa, My king, I use evritin wey dey holy take swear sey, e nor get how I go take dodge yor kweshon. Na Joab wey bi yor offisa tell mi wetin I go do and wetin I go tok.
2SA 14:20 But e do am to take solve dis problem. My king get sense like angel and e know evritin wey dey happen.”
2SA 14:21 So di king koll and tell Joab, “I don gri to do wetin yu wont. So make yu go look for Absalom kon bring am kom back.”
2SA 14:22 Joab bow for David kon sey, “My king, make God bless yu! Naw, I know sey yu dey happy with mi, bikos yu gri with wetin I tok.”
2SA 14:23 Den e go Geshur go bring Absalom kom Jerusalem.
2SA 14:24 But di king give orda sey make Absalom nor stay for di palis. Di king sey, “I nor won si am.” So Absalom go stay for en own house and e nor kom where di king dey.
2SA 14:25 E nor get pesin wey fine rish Absalom for Israel. From en head go rish leg, evriwhere dey okay.
2SA 14:26 En hair tick and heavy well-well sotey na wons e dey kut am a year wen e don too long. En hair heavy rish five pounds if dem use palis standard take measure am.
2SA 14:27 Absalom born three boys and one girl wey dem dey koll Tamar and e fine well-well.
2SA 14:28 Absalom stay two years for Jerusalem and e nor si di king.
2SA 14:29 Den Absalom send message go koll Joab make e go meet di king for am, but Joab nor gri kom. Absalom send for am again and e nor gri kom.
2SA 14:30 So Absalom tell en savant, “Si, Joab farm near my own and e plant barley put. Make una go burn am.” So dem kon go burn di field.
2SA 14:31 Joab go Absalom house kon tell am, “Wetin make yor savants burn my farm?”
2SA 14:32 Absalom ansa, “Bikos yu nor gri kom wen I sey make yu kom. I wont make yu go meet di king kon ask am: ‘Wetin make mi komot from Geshur kom stay here? E for betta for mi pass dis place wey I dey so.’ ” Absalom still sey, “I wont make yu arrange for mi make I si di king and if I dey guilty, make dem kill mi.”
2SA 14:33 So, Joab go meet David kon tell am wetin Absalom tok. Di king send message go koll Absalom kom and wen e kom, e bow for di king front, den di king welkom am with kiss.
2SA 15:1 Afta dis, Absalom make war horse dem for ensef with fifty men wey go escort am.
2SA 15:2 For early morning, e go-go stand for road near di town gate and anytime pesin won kom meet di king make e setol dia kworel, Absalom go koll and ask am where e from kom. And wen di man don tell am di tribe wey e kom from,
2SA 15:3 Absalom go tell am, “Si, una dey rite for wetin una dey do, but e nor get anybody wey won ripresent di king make e for listin to una.”
2SA 15:4 E go sey, “If to sey dem go make mi judge for dis land, den anybody wey get kworel go kom meet mi and I go make sure sey dem judge en kase well.”
2SA 15:5 Wen anybody waka go bow for Absalom, e go hold di pesin stand up kon kiss am.
2SA 15:6 E dey do like dis to evribody for Israel wey dey kom meet di king make e judge dia matter. Like dis, evribody for Israel kon dey respet am.
2SA 15:7 Afta four years, Absalom tell en papa David, “My oga, make I go Hebron go do wetin I promise God.
2SA 15:8 Wen I dey Geshur for Siria, I promise God sey, if E bring mi kom back to Jerusalem, I go-go Hebron go woship am.”
2SA 15:9 Di king ansa, “Make peace follow yu.” So Absalom kon go Hebron.
2SA 15:10 But e send message go give all di pipol wey dey Israel tribe sey, “If una hear trumpet sound, den make una shaut, ‘Absalom don bi Hebron pipol king!’ ”
2SA 15:11 Na two hundred men from Jerusalem, Absalom karry follow body. Bikos dem nor know wetin Absalom won do, dem kon follow am with klean mind.
2SA 15:12 As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.
2SA 15:13 One messenja kon go tell David, “All di pipol for Israel dey loyal to Absalom.”
2SA 15:14 So David tell all en ofisas wey dey with am for Jerusalem, “Make wi run at wons, so dat Absalom nor go kill us! Make una hurry or e go kom defeat and kill evribody for di town!”
2SA 15:15 Dem ansa, “Yes o-o, awa king! Wi dey ready to do anytin wey yu tok.”
2SA 15:16 So di king karry all en family pipol with di ofisas kon leave ten of en girl-friend wey go look di palis.
2SA 15:17 As di king and all en men dey komot for di palis, dem kon stop for di last house.
2SA 15:18 All di ofisas stand near am as di royal bodyguard pass go en front. Di six hundred sojas wey follow am from Gat still pass go en front,
2SA 15:19 den di king tell Ittai wey bi dia leader sey, “Why yu won follow us go?” Go back make yu go stay with di new king. Yu bi strenja wey dem porshu komot en kountry.
2SA 15:20 “E neva too tey wey yu kom here, so wetin go make mi allow yu sofa with mi? I nor even know where I dey go. So, make yu go back go meet yor pipol and make God dey kind and trit una well.”
2SA 15:21 But Ittai ansa, “My king, I use God name take swear sey I go follow yu go anywhere wey yu dey go, even if I go die put.”
2SA 15:22 David ansa, “Okay! Make wi dey go!” So Ittai with en men kon follow David.
2SA 15:23 All di pipol for di town bigin kry as David with en men dey go. Di king with en men wey dey follow am kon cross go Kidron Valley as dem waka face di wildaness.
2SA 15:24 Zadok wey bi di priest with Levi pipol, wey karry di Kovenant Box, dey der too. Dem put am for groun, offa sakrifice and dem nor karry am again until all di pipol komot from di town. Even Priest Abiatar dey der too.
2SA 15:25 Den di king tell Zadok, “Make una karry di Kovenant Box go di town back. If God dey happy with mi, E go still let mi kom back kom si am for where e dey.
2SA 15:26 But if E dey vex for mi, make E do wetin E like with mi.”
2SA 15:27 Di king tell Zadok, “Look! Make yu take Ahimaaz yor pikin and Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon go di town back with peace.
2SA 15:28 Den I go dey wait for di river where dem for dey cross go di wildaness until I hear news from una.”
2SA 15:29 So Zadok and Abiatar karry di Kovenant Box go Jerusalem kon stay der.
2SA 15:30 David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.
2SA 15:31 Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”
2SA 15:32 Wen David rish on-top di hill where e go for fit woship God, en friend, Hushai wey kom from Ark land, wey David trust well-well, kom meet am. E wear tear-tear klot kon pak dirty full en head.
2SA 15:33 David tell am, “Even if yu follow mi, yu nor go fit help mi do anytin,
2SA 15:34 but yu fit help mi, if yu go di town back go tell Absalom sey yu go dey faithful to serve am just as yu serve en papa. Den make yu do evritin wey yu fit do against all di advise wey Ahitofel go gi-am.
2SA 15:35 Zadok and Abiatar wey bi priest go dey der. So make yu tell dem evritin wey yu hear from di king palis.
2SA 15:36 Ahimaaz and Jonatan, dia shidren dey der with dem and yu fit send dem with all di informashon wey yu get kom give mi.”
2SA 15:37 So Hushai, wey bi David friend kon go di town back as Absalom just dey enter.
2SA 16:1 Wen David don pass di hill small, e kon si Ziba wey bi Mefiboshet savant. E bring some donkey wey karry two hundred bread and some kake; one hundred fresh fruit and one leda bag wey wine full.
2SA 16:2 David ask am, “Wetin yu won use all dis tin do?” Ziba ansa, “Di donkey na for my king, David family, di bread and di fruit na for di men to chop and na di wine dem go drink wen dem don taya for di wildaness.”
2SA 16:3 Di king ask am, “Where Mefiboshet, yor masta, Saul grand-pikin?” Ziba ansa, “E dey for Jerusalem, bikos dem tell am sey Israel pipol go gi-am en grand-papa Saul, kingdom back.”
2SA 16:4 Di king tell Ziba, “Evritin wey Mefiboshet get, don turn yor own.” Ziba ansa, “I go always bi yor savant! Make I always dey do wetin dey good for my king eyes!”
2SA 16:5 Wen David rish Bahurim, one Saul relashon wey dem dey koll Shimei wey bi Gera pikin kom out bigin curse David.
2SA 16:6 Shimei start to stone David, en ofisas and en bodyguards.
2SA 16:7 Shimei curse am dey sey, “Make yu get out! I sey make yu dey go! Yu wey kill pipol! Wiked man!
2SA 16:8 Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”
2SA 16:9 Abishai wey en mama name bi Zeruaya kon tell di king, “My king, why yu dey let dis dog curse yu? Make I go der go kut en head komot!”
2SA 16:10 But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”
2SA 16:11 David tell Abishai and all en ofisas, “My own pikin one kill mi, so why una dey sopraiz for dis man wey kom from Benjamin tribe? Na God tell am make e curse mi, so make una leave am make e dey curse.
2SA 16:12 May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”
2SA 16:13 As David and en men dey waka pass, Shimei still follow dem rish di hill and e dey curse, dey trow stones and dirty for dia body.
2SA 16:14 Di king and all en men taya well-well wen dem rish Jordan River, so dem kon rest for der.
2SA 16:15 Absalom and Israel pipol enter Jerusalem and Ahitofel dey with dem.
2SA 16:16 Wen Hushai, David friend wey e trust well-well si Absalom, e kon shaut, “Di king go live forever! Di king go rule us tey well-well!”
2SA 16:17 Absalom kon ask am. “Wetin happen wey make yu nor dey loyal to yor friend David again? Why yu nor follow am go?”
2SA 16:18 Hushai ansa, “How I go follow am, I dey follow di one wey God choose for Israel pipol. I go stay with yu.
2SA 16:19 Even sef, na who I go serve, if nor bi my oga pikin? As I serve yor papa, na so I go take serve yu naw.”
2SA 16:20 Den Absalom tell Ahitofel, “Naw wey wi don dey here, wetin yu advise make wi do?”
2SA 16:21 Ahitofel ansa, “Go sleep with yor papa girl-friends wey e leave for di palis. Den evribody for Israel go know sey yor papa hate yu and doz wey dey follow yu, go kon get heart.”
2SA 16:22 So dem set one tent for di palis roof for Absalom and for evribody present, Absalom enter kon sleep with en papa girl-friends.
2SA 16:23 Dat time, any advise wey Ahitofel give, David and Absalom dey do as e tok, bikos dem bilive sey God dey tok thru am.
2SA 17:1 Afta sometaim, Ahitofel tell Absalom, “Make I choose 12,000 men wey go-go find David dis nite.
2SA 17:2 I go attack am wen e don taya and dey konfuse. E go fear and all en men go run, den I go kill only di king.
2SA 17:3 I go bring all en men kon give yu like new wife wey dey go meet en husband. Na only one man yu won kill and all di rest pipol go dey save.”
2SA 17:4 Absalom and all Israel leaders like di advise.
2SA 17:5 So Absalom sey, “Make una koll Hushai make wi hear wetin e won tok.”
2SA 17:6 Wen Hushai kom, Absalom tell am, “Si di advise wey Ahitofel give us, make wi follow am? If yu nor gri, tell us wetin wi go do.”
2SA 17:7 Hushai ansa, “Di advise wey Ahitofel give yu dis time nor good.
2SA 17:8 Yu know sey, David yor papa and en men strong well-well for fight, like bear for bush wey dey find en pikin. Yor papa na soja wey get sense and e nor dey stay with en men for nite.
2SA 17:9 E fit hide for kage and oda place dis time. If David attack and win yor men, anybody wey go hear am go sey, dem don win una.
2SA 17:10 Den all di men wey dey strong like lion go dey fear, bikos evribody for Israel know sey yor papa na great soja and en men dey fight well-well.
2SA 17:11 “I dey advise yu sey make yu bring all Israel pipol togeda, even doh dem many like san for wotaside kon skata for evriwhere for di kountry. Make yu yorsef lead dem go di war.
2SA 17:12 Wi go find and attack David for anywhere wey e dey, before e go know wetin dey happen. Nobody among en and en men go survive.
2SA 17:13 If e enter any town, awa pipol go use rope pul di town fall for di valley. No stone go remain for di hill top.”
2SA 17:14 Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.
2SA 17:15 Den Hushai tell Zadok and Abiatar wey bi priest about di advise wey e give Israel leaders and di advise wey Ahitofel give dem.
2SA 17:16 Hushai still sey, “Make una kwik dey go naw kon tell David make e nor stay for where e dey dis nite for di desert, but make e cross Jordan River, so dat dem nor go kill en and en men.”
2SA 17:17 Abiatar pikin, Jonatan and Zadok pikin, Ahimaaz bin dey wait for En-Rogel wotaside wey dey for Jerusalem ending, bikos dem nor fit enter di town. One girl wey bi savant dey go tell dem wetin dey happen all di time and dem go-go tell David.
2SA 17:18 But one day, one boy si dem kon go tell Absalom, so dem kon go hide for one man house for Bahurim. Dem hide inside di well wey dey en kompond.
2SA 17:19 Di man wife kon use sometin kover di well, den spread rice put, so dat nobody go know wetin dey der.
2SA 17:20 Absalom ofisas kom di house kon ask di woman, “Where Ahimaaz and Jonatan?” Di woman ansa, “Dem don cross di river.” Di men look for dem, but dem nor si dem. So, dem go back to Jerusalem.
2SA 17:21 Afta dem don komot, Jonatan and Ahimaaz kom out from di well go tell David wetin dey happen. Dem tell am wetin Ahitofel plan against am kon sey, “Oga, make wi kwik-kwik cross di river.”
2SA 17:22 So David and all en men bigin cross Jordan River before day break.
2SA 17:23 Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.
2SA 17:24 For di time wey Absalom and Israel pipol cross Jordan River, David don already rish Mahanaim town.
2SA 17:25 Absalom sey make Amasa take Joab place as di sojas oga. Amasa na Itra pikin wey kom from Ishmael tribe and en mama name na Abigail, Nahash pikin. Zeruaya wey born Joab, na en sista bi Nahash.
2SA 17:26 Absalom and en men kamp for Gilead town.
2SA 17:27 Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.
2SA 17:28 Dem bring basin, pots and bed shit kom gi-am. Dem still bring food: wheat, barley, grain wey dem roast, beans, peas, honey, cheese, cream and some sheep kom give David and en men.
2SA 17:29 Dem know sey David and en men go dey hongry and wota don dey hongry dem since for di wildaness.
2SA 18:1 David gada en men kon divide dem into tazon-tazon and hundred-hundred, den e put offisa make e dey kommand dem.
2SA 18:2 E divide dem into three groups kon send dem out. Na Joab, Abishai wey bi Joab broda and Ittai wey kom from Gat, dey kommand each group. Di king tell en men, “I go follow una go.”
2SA 18:3 But dem ansa. “Yu nor go follow us, bikos e nor go mean anytin to di enemy if wi wey remain turn and run or even if dem kill half of us, but only yu bi like 10,000 of us. E go betta make yu stay here dey send help kom give us.”
2SA 18:4 Di king ansa, “Wetin una tink sey dey good pass, naim I go do.” Den e stand near di gate as en men dey go. Hundred-hundred and tazon-tazon.
2SA 18:5 E give Joab, Abishai and Ittai ordas sey, “Make una nor tosh Absalom bikos of mi.” And all di sojas hear wen David give en ofisas dis kommand.
2SA 18:6 David sojas go di kountry on-top di hill and dem fight Israel pipol for Efraim forest.
2SA 18:7 David men defeat Israel pipol kon kill 20,000 men dat day.
2SA 18:8 Di fight spread go di kountry side and di men wey die for di forest, plenty pass di ones wey dem kill for war.
2SA 18:9 At wons, Absalom si some of David men. So Absalom enter en horse dey run and as e dey pass under one big oak tree, di tree branches kon hook en head and e struggol till e die, bikos di horse run leave am.
2SA 18:10 One among David men si am kon go tell Joab sey, “Awa oga! I si Absalom hang for one oak tree!”
2SA 18:11 Joab ansa, “If yu si am, why yu nor kill-am for der? I for give yu ten pieces of silva with belt.”
2SA 18:12 But di man ansa, “Even if yu give mi one hundred pieces of silva, I nor go use my hand kill di king pikin. All of us hear wen di king dey kommand yu, Abishai and Ittai sey, ‘Bikos of mi, make una nor tosh or kill Absalom.’
2SA 18:13 But if I nor obey di king kon kill Absalom, di king for hear am, bikos e dey hear evritin and yu nor for defend mi.”
2SA 18:14 Joab ansa, “I nor go waste time with yu again.” So e take three spear kon shuk Absalom for chest, even as e dey struggol for di tree wey e hang put.
2SA 18:15 Den ten of Joab sojas kon follow am kill Absalom.
2SA 18:16 Joab hear as dem blow di trumpet make di fight for stop and en sojas wey dey porshu Israel pipol kon kom back.
2SA 18:17 Dem karry Absalom body trowey for one deep pit for di forest kon use many stone kover am. So Israel pipol kon run go dia house.
2SA 18:18 Wen Absalom dey alive, e build one big house for di King Valley for ensef. Since e nor born boy pikin wey go ansa en name, e kon give di house en own name and till today, dem dey koll di house, “Absalom Monument.”
2SA 18:19 Den Ahimaaz wey bi Zadok pikin kon tell Joab, “Make I run go tell David di good news sey God don save am from en enemies.”
2SA 18:20 Joab kon sey, “No! Yu nor go tell anybody good news today wey king pikin die, so make yu wait till anoda day.”
2SA 18:21 Den e tell en savant wey kom from Sudan, “Make yu go tell di king wetin yu si.” So di savant bow kon run go.
2SA 18:22 Ahimaaz still sey, “I nor dey fear wetin go happen, I go-go tok di news too.” Joab ask am, “My pikin, wetin make yu won go tok? Dem nor go give yu any reward o-o.”
2SA 18:23 Ahimaaz ansa, “Anytin wey won happen, make e happen, I go-go tell am.” Joab ansa, “Oya! Make yu go.” So Ahimaaz run from Jordan River Valley pass di savant for road.
2SA 18:24 David sidan for di space wey dey between di inside and outside gate for di town. Di guide stand on-top di roof wey dey di gate kon si only one man dey run kom.
2SA 18:25 E kom down kon tell di king and di king sey, “If na only en dey kom, e dey bring good news.” Di man still dey run kom.
2SA 18:26 Den di guide si anoda man dey run kom for di road and e koll di pesin wey dey keep di gate sey, “Si, anoda man dey run kom!” Di king ansa, “Dis one still dey bring good news too.”
2SA 18:27 Di guide kon sey, “Di first man wey I dey si so, dey run like Ahimaaz.” Di king ansa, “E bi good man and e dey bring good news kom.”
2SA 18:28 Ahimaaz greet di king kon bow for en front sey, “My king! Make yu praiz di Oga wey bi yor God, wey don give yu viktory ova yor enemies!”
2SA 18:29 Di king kon ask, “Wot of Absalom?” Ahimaaz ansa, “Oga God! Wen Joab yor offisa send mi, I si big wahala, but I nor fit tok wetin e bi.”
2SA 18:30 Di king kon tell am, “Make yu stand for der!” So Ahimaaz go where e tell am.
2SA 18:31 Den di Sudan savant kom tell di king, “I get good news for my king! God don give yu viktory against all di pipol wey dey fight yu!”
2SA 18:32 Di king ask am too, “Absalom still dey life?” Di savant ansa, “I wish sey wetin happen to am go happen to all yor enemies and all doz wey dey fight yu.”
2SA 18:33 Di king nor kon happy again. So e go di room wey dey di gate side kon bigin kry. As e dey go, e dey kry sey, “O-o! My pikin Absalom! Absalom my pikin, e for betta sey na mi die, instead of yu!”
2SA 19:1 Dem kon tell Joab sey David dey kry and mourn for Absalom.
2SA 19:2 So, instead make di sojas dey happy sey dem win, all of dem kon dey mourn, bikos dem hear sey di king dey kry for en pikin.
2SA 19:3 Dem kwayet enter di town with shame like sojas wey dem win for war.
2SA 19:4 Di king kover en face bigin kry dey sey, “O-o my pikin! O-o my pikin Absalom! Absalom my pikin!”
2SA 19:5 Joab go di king house kon tell am, “Today, yu don disgrace yor men, di men wey save yu, yor shidren, wifes and yor girl-friends.
2SA 19:6 Yu dey oppoz doz wey love yu kon support doz wey hate yu! Yu don make am klear sey yor ofisas and men know mean anytin to yu. I si sey yu go dey happy if to sey na wi die and Absalom dey life.
2SA 19:7 Naw, make yu go make yor men heart strong. I use God name take swear sey if yu know go meet dem, nobody go stay here with yu dis nite. Na dat go bi di worse wahala wey yu go ever si for yor life.”
2SA 19:8 Den di king get up go sidan for di gate. Wen dem tell all di pipol sey di king sidan for di gate, all of dem kon go meet am. But all di men for Israel don go back to dia house.
2SA 19:9 All di pipol for Israel kon dey kworel among demsef sey, “King David save us from awa enemies. E save us from Filistia pipol, but naw, e don run komot from di kountry bikos of Absalom.
2SA 19:10 Wi anoint Absalom make e bi awa king, but dem don kill-am for war. So why wi nor go-go bring David back?”
2SA 19:11 David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?
2SA 19:12 Na una bi my relashon, my flesh and blood, why una go bi di last tribe wey go bring mi kom back?”
2SA 19:13 David still tell dem make dem tell Amasa, “Una bi my own relashon, from today go, I dey put yu for Joab place make yu rule my sojas. Make God ponish mi if I nor do wetin I tok!”
2SA 19:14 So wetin David tok, enter Judah men heart and dem obey am kon send message go meet en and all en ofisas make dem kom back.
2SA 19:15 Wen David dey go back, e kon si Judah men for Jordan River and dem kom Gilgal kon escort am cross di river.
2SA 19:16 For dat time, Shimei from Benjamin tribe wey bi Gera pikin wey dey stay Bahurim kon run go Jordan River go meet David.
2SA 19:17 E take 1,000 men from Benjamin tribe, Ziba wey bi savant for Saul family, en fifteen sons and twenty savants go meet di king for Jordan River.
2SA 19:18 Dem escort di king and en pipol cross di river and dem do evritin wey di king wont. As di king won cross, Shimei fall for di king front
2SA 19:19 kon sey, “My king, abeg, make yu forget all di bad tins wey I do dat day wey yu komot from Jerusalem, nor kount am against mi or tink am at-all.
2SA 19:20 My oga, I know sey I don sin and na dis make mi bi di first pesin from Josef tribe wey kom meet yu, my king.”
2SA 19:21 Abishai wey bi Zeruaya pikin kon sey, “Make dem kill Shimei, bikos e curse di pesin wey God choose to bi king.”
2SA 19:22 But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”
2SA 19:23 Den e tell Shimei, “I promise yu sey nobody go kill yu.”
2SA 19:24 Den Mefiboshet wey bi Saul grand-pikin, kom meet di king. E neva wosh en leg; kut en hair or wosh en klot since di time wey di king komot from Jerusalem till naw wey e dey kom back with viktory.
2SA 19:25 Wen Mefiboshet meet di king from Jerusalem, di king tell am, “Mefiboshet, why yu nor follow mi go?”
2SA 19:26 E ansa, “My king, yu know sey I nor fit waka. I tell my savant make e karry mi for donkey follow yu, but e run leave mi.
2SA 19:27 E tell di king lie about mi, but yu bi like God angel, so make yu do wetin dey good for mi.
2SA 19:28 E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”
2SA 19:29 Di king ansa, “Make yu nor tok again. I don tok before sey, yu and Ziba go divide Saul propaty.”
2SA 19:30 Mefiboshet ansa, “Make Ziba take evritin! My king, as yu kom house save, dat one don do for mi.”
2SA 19:31 Barzillai wey kom from Gilead still kom from Rogelim make e for escort di king cross Jordan River.
2SA 19:32 Dat time, Barzillai na eighty years; e get money well-well and e feed di king wen e dey for Mahanaim.
2SA 19:33 So di king tell am, “Make yu follow mi go Jerusalem and I go kare for yu.”
2SA 19:34 But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?
2SA 19:35 I don old rish eighty years and nor-tin dey make mi happy again, I nor dey taste or enjoy wetin I dey chop or drink and I nor dey hear pipol wen dem dey sing again. So if I follow yu go, na wahala I go just bi to yu.
2SA 19:36 Dat kind big reward nor fit mi. So I go follow yu pass Jordan River small.
2SA 19:37 Make yu let mi go house go die near my papa and mama grave. Si Kimham my pikin, make e serve yu. My king, make e follow yu, den do wetin yu know sey dey good for am.”
2SA 19:38 Di king ansa, “I go take am follow body kon do wetin yu wont for am. I go do anytin wey yu ask.”
2SA 19:39 Den David and all en men cross Jordan River. E kiss and bless Barzillai and Barzillai kon go back to en house.
2SA 19:40 Wen all di men for Judah and half of di men for Israel don escort di king cross, David kon go Gilgal. Kimham wey bi Barzillai pikin, follow am go.
2SA 19:41 Den Israel pipol go meet di king kon sey, “Awa king, wetin make awa brodas for Judah hide escort yu, yor family and yor men cross Jordan River?”
2SA 19:42 Judah men ansa, “Wi do am, bikos di king na one of us. So, wetin make una dey vex? Nor bi sey e don pay for awa food or give us anytin.”
2SA 19:43 Israel pipol ansa, “Even doh David bi one of una, wi get am ten times, pass as una get am. Why una dey look us like sey wi bi small pikin or sey wi nor mean anytin? Make una nor forget sey, Na wi first sey make dem bring di king kom back!” But wetin Judah men dey tok, strong pass di mout wey Israel men dey make.
2SA 20:1 E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”
2SA 20:2 So Israel pipol leave David kon follow Sheba, but Judah men obey and follow David from Jordan River go Jerusalem.
2SA 20:3 Wen David rish en palis for Jerusalem, e take en ten girl-friends wey e leave make dem kare for di place kon sey make dem guide dem. E give dem evritin wey dem wont, but e nor sleep with dem. And still dem die, e keep dem like wimen wey dia husband don die.
2SA 20:4 Di king tell Amasa, “Make yu koll all Judah men kom meet mi di day afta tumoro.”
2SA 20:5 So Amasa go koll dem, but e nor kom back wen di king sey make e kom.
2SA 20:6 So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”
2SA 20:7 So Joab men, di king bodyguard and all di oda sojas komot from Jerusalem with Abishai go find Sheba.
2SA 20:8 Wen dem rish di big rock for Gibeon, Amasa kon si dem. Joab wear en war klot kon tie e swod with en belt. As e waka go front small, en swod kon fall.
2SA 20:9 Joab kon tell. Amasa, “My friend, how yu dey?” E kon hold en hair with en rite hand like sey e won kiss am.
2SA 20:10 Amasa nor protet ensef against di swod wey Joab hold for en oda hand, so Joab shuk am for belle and en intestine kom out. Amasa just die at wons and Joab nor nid to shuk am again. Den Joab and Abishai, en broda kon go find Sheba.
2SA 20:11 One of Joab men stand near Amasa dead body bigin shaut, “All di pipol wey dey Joab and David side, make una follow Joab!”
2SA 20:12 Amasa body dey di road centre and en blood spread around am. Wen Joab men si sey evribody dey stop wen dem si di body, dem drag di body enter di bush korna kon kover am with klot.
2SA 20:13 Wen dem don remove di body from di road, evribody kon follow Joab porshu Sheba.
2SA 20:14 Sheba run pass all Israel pipol aria go Abel-Bet Maaka town and all di pipol for Bikri village gada follow am enter di town.
2SA 20:15 Wen Joab men hear sey Sheba dey der, dem kon build tick wall round di town, so Joab men kon bigin dig di wall so dat e go skata fall.
2SA 20:16 E get one woman wey get sense well-well for di town, so e shaut from di wall sey, “Make una listin! Make una listin! Make una tell Joab make e kom here, bikos I won tok to am.”
2SA 20:17 Joab go meet am and di woman sey, “Na yu bi Joab?” E ansa, “Yes, na mi.” E sey, “My oga, make yu listin to mi.” Joab ansa, “I dey listin.”
2SA 20:18 Di woman sey, “Before-before, dem bi dey sey, ‘Go get yor ansa for Abel town’ and dat na di only tin wey dem sabi do.
2SA 20:19 Awa town na big one wey get peace and pipol dey respet us for Israel. Why yu won distroy am? Yu won skata wetin bi God own?”
2SA 20:20 Joab ansa, “No o-o! I nor go fit distroy una town!
2SA 20:21 Nor bi awa plan bi dat. One man wey dem dey koll Sheba wey bi Bikri pikin, wey kom from Efraim hill kountry, naim start di fight with King David. If una bring dis man kom out, I go leave una town.” Di woman kon sey, “Wi go trow en head pass di wall kon give una naw-naw.”
2SA 20:22 Den e go meet di town pipol with en plan, so dem kut Sheba head kon trow am go give Joab for di oda side for di wall. Joab blow en trumpet take tell en men sey make dem leave di town and dem kon go house go meet di king for Jerusalem.
2SA 20:23 Na Joab dey kommand Israel pipol soja, while Benaya wey bi Jehoiada pikin dey kontrol David bodyguard.
2SA 20:24 Adoniram dey kontrol doz wey dey work and na Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep di rekord.
2SA 20:25 Na Sheva bi di kourt seketry, while Zadok and Abiatar na priests
2SA 20:26 and Ira wey kom from Jair town still dey among David priests.
2SA 21:1 Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”
2SA 21:2 Gibeon pipol nor dey join Israel pipol; dem bi small tribe for Amor wey Israel pipol promise sey, dem go protet, but Saul don try to distroy dem, bikos of en love for Judah and Israel pipol.
2SA 21:3 So David koll Gibeon pipol kon tell dem, “Wetin I go fit do for una? I won do good for di bad tins wey dem don do una, so dat una go bless God pipol.”
2SA 21:4 Dem ansa, “Di kworel wey wi get with Saul, dem nor fit setol am with silva and gold and wi nor won kill any Israel pesin.” So David ask dem again, “Wetin una wont make I do for una?”
2SA 21:5 Dem ansa, “Saul won distroy all of us komot from Israel.
2SA 21:6 So make yu give us seven of en grand sons and wi go hang dem give God for Gibeah, wey bi Saul, di king wey God choose town.” Di king ansa, “I go give una.”
2SA 21:7 But bikos of di holy promise wey en and Jonatan don make give diasef, David nor kill Jonatan pikin wey dem dey koll Mefiboshet, wey bi Saul grand-pikin.
2SA 21:8 But e take Armoni and Mefiboshet, di sons wey Rizpah born for Saul and na Aiaya bi Rizpah papa. E still take Saul dota, Merab five sons; den Barzillai wey kom from Meholah, di king take en pikin, Adriel.
2SA 21:9 David give dem to Gibeon pipol and dem kon hang dem give God for di mountin. Dis tin happen before dry sizin start and dem won start to harvest barley.
2SA 21:10 Den Saul girl-friend, Rizpah, wey Aiaya born kon use sak klot take make house for ensef for where di dead body dem dey and e stay der from harvest time go rish wen heavy rain start to fall. E go drive birds komot from di dead body for day time kon keep dem from bad animal for nite.
2SA 21:11 Wen David hear wetin Rizpah do,
2SA 21:12 e kon go kollect Saul and Jonatan en pikin bones from Jabesh pipol for Gilead. (Dem bin karry dem form Bet-Shan for where dem hang dem put afta Filistia pipol kill Saul for Mount Gilboa.)
2SA 21:13 David karry Saul, Jonatan and di seven men wey dem hang bones,
2SA 21:14 den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.
2SA 21:15 Israel and Filistia pipol bigin fight again, so David with en men go fight dem. As dem dey fight, David kon taya well-well to fight.
2SA 21:16 One giant wey dem dey koll Ishbi-Benob, wey karry bronze spear wey heavy rish seven and half pounds with new swod kon tink sey e fit kill David.
2SA 21:17 But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
2SA 21:18 Afta dat one, dem fight with Filistia pipol for Gob and Sibbekai wey kom from Hushah kill one giant wey dem dey koll Saf.
2SA 21:19 Dem still fight with Filistia pipol for Gob again and Elhanan, Jair pikin wey kom from Betlehem kon kill Goliat wey kom from Gat. En spear mout tick rish di shaft wey dem take dey weave klot.
2SA 21:20 Dem fight again for Gat and e get one giant for der wey like fight well-well. E get six finger for en hand and leg.
2SA 21:21 E trobol Israel pipol well-well, so Jonatan wey bi David broda Shimei pikin kon kill-am.
2SA 21:22 Dis four men na Gat giant grand-shidren and na David and en men kill dem.
2SA 22:1 David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:
2SA 22:2 “Na di Oga awa God dey protet mi; Na-im dey diliver mi.
2SA 22:3 Na God dey protet and save mi. Na-im bi my shield and E dey defend mi. E dey protet and save mi from danger.
2SA 22:4 I go praiz God, bikos wen ever I koll am, E dey save mi from my enemies!
2SA 22:5 Deat dey round mi; e bi like sey dem go soon distroy mi.
2SA 22:6 Deat really dey around mi and grave set trap for mi.
2SA 22:7 Wen I dey trobol, I koll Oga God; I koll my God make E help mi. E hear my vois for en temple kon listin and help mi wen I dey kry.
2SA 22:8 Den di eart bigin shake dey fear, di sky foundashon bigin shake too, bikos God bin dey vex!
2SA 22:9 Smoke dey kom out from en nose, while fire and shako dey kom out from en mout.
2SA 22:10 E tear di sky open kon kom down with one black kloud for en leg.
2SA 22:11 E dey fly with en shariot for heaven; E dey travel with di wind.
2SA 22:12 E kover ensef with darkness and tick kloud wey wota full dey round am.
2SA 22:13 Shako with fire dey kom out for en front.
2SA 22:14 Oga God dey bring tonda from di sky and evritin dey hear wen God wey get pawa dey tok.
2SA 22:15 E shot en arrow take skata en enemies. E use strong lite take make dem run.
2SA 22:16 Di river dry finish and di eart foundashon kon open so God nor keep silent and E kon shaut for en enemies with vexnashon.
2SA 22:17 God kom down from heaven kon hold mi. E draw mi komot from di wota wey deep well-well.
2SA 22:18 E save mi from my strong enemies and all di pipol wey hate mi, bikos dem too strong for mi.
2SA 22:19 Wen I dey trobol, dem attack mi, but God protet mi.
2SA 22:20 Bikos E dey happy with mi, E help mi wen I dey trobol kon save mi.
2SA 22:21 God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E bless mi, bikos I dey innocent.
2SA 22:22 I don obey God law; I neva turn from my God before.
2SA 22:23 I don keep all en laws; I neva disobey en kommand.
2SA 22:24 E know sey I nor get fault and I nor dey do bad tins.
2SA 22:25 So E reward mi, bikos I dey do wetin dey rite, bikos E know sey I dey innocent.
2SA 22:26 My Oga God, Yu dey faithful to doz wey dey faithful to Yu and Yu dey good to pipol wey dey good.
2SA 22:27 Yu dey pure to doz wey dey pure, but Yu show wikedness to wiked pipol.
2SA 22:28 Yu dey save pipol wey dey honbol, but Yu dey honbol pipol wey dey proud.
2SA 22:29 Oga God! Na Yu bi my lite; Yu don remove my darkness.
2SA 22:30 Yu give mi pawa take attack my enemies kon ovakom dem.
2SA 22:31 Di tins wey dis God dey do, dey pafet. Make wi trust en words! E dey kover pipol wey wont make E protet dem.
2SA 22:32 Na di Oga bi God and na only God dey defend us.
2SA 22:33 Na inside God I hide put; E dey make my road save.
2SA 22:34 E make my foot dey save like deer kon keep mi save for di mountin.
2SA 22:35 E dey train mi for war, so dat I go use di bow wey strong well-well.
2SA 22:36 My Oga God! Yu protet and save mi; Yu don make mi great.
2SA 22:37 Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi and I nor fall.
2SA 22:38 I porshu and defeat my enemies; I nor stop till I distroy dem finish.
2SA 22:39 I nak dem fall and dem nor fit stand again, bikos I defeat dem.
2SA 22:40 Yu give mi pawa for war and viktory ova my enemies.
2SA 22:41 Yu dey make my enemies run from mi and I distroy doz wey hate mi.
2SA 22:42 Dem dey look for help, but nobody dey to save dem. Dem koll God, but E nor ansa dem.
2SA 22:43 I skata and turn dem to san. I dey waka on-top dem like mud for street.
2SA 22:44 Yu save mi from my own pipol wey fight mi kon make mi dey always rule di nashons and even pipol wey I nor know, dey under mi.
2SA 22:45 Doz wey kom from anoda land dey bow for mi and wen dem si mi, dem dey obey.
2SA 22:46 Anywhere wey dem hide put, dem dey run komot der, bikos dem dey fear.
2SA 22:47 God go dey forever! Make wi praiz di Pesin wey dey defend mi! Make una tok how God wey save mi strong rish!
2SA 22:48 E give mi viktory ova my enemies kon put di nashons under mi.
2SA 22:49 My Oga God! Yu save mi from my enemies kon give mi viktory and protet mi from wiked men.
2SA 22:50 So, I dey praiz Yu among all di nashon; I go sing praiz Yu.
2SA 22:51 God dey give en king great viktory. E dey always show love to di pesin wey E choose and na mi, David with my shidren-shidren go rule forever.”
2SA 23:1 David wey bi Jesse pikin, na God make am great well-well. Na dis pesin, Jakob God choose as king and na-im rite betta songs for Israel pipol. Dis na di last words wey David tok:
2SA 23:2 “God Spirit dey tok thru mi; en message dey for my lip.
2SA 23:3 Israel God don tok, di Pesin wey dey protet Israel tell mi sey: ‘King wey dey rule well and fear God,
2SA 23:4 bi like sun wey shine for morning; di sun wey dey make grass shine afta rain don fall put.’
2SA 23:5 Na so God go take bless my shidren-shidren, bikos E don make kovenant wey go last forever with mi: agriment wey nor dey break and promise wey nor dey shange. Na wetin go give mi viktory bi dat and God go make am happen.
2SA 23:6 But doz wey nor know God bi like shuku-shuku wey dem trowey; nobody fit tosh dem with ordinary hand,
2SA 23:7 instead, pesin must use iron or spear take gada and burn dem.”
2SA 23:8 Dis na David sojas wey get pawa well-well: Di first one na Josheb-Basshebet wey kom from Tahkemon and naim bi di leader for, “Di Three”, e fight with eight hundred men and e kill dem for one war.
2SA 23:9 Di sekond one for Di Three wey get pawa, na Eleazar wey bi Dodo pikin from Ahohi family. One day, en and David shalenge Filistia pipol wey gada for war, even wen Israel pipol run go back,
2SA 23:10 e stand fight till en hand bigin pain am and en swod kon gum en hand. God give dem viktory dat day. Wen Israel pipol go meet Eleazar afta di fight, di only tin wey remain for dem to do, na to kollect all di tins wey Filistia sojas die leave.
2SA 23:11 Di third one for Di Three wey get pawa, na Shammah wey bi Agee pikin wey kom from Harar. Wen Filistia pipol gada for Lehi where dem plant peas put, Israel pipol run from dem,
2SA 23:12 but Shammah nor run and e fight and kill all of dem. God give dem viktory dat day.
2SA 23:13 Wen di time to harvest don rish, three out of “Di Thirty” kon go Adullam Kave where David dey and many Filistia pipol kamp for Refah Valley.
2SA 23:14 Dat time, David dey for one hill wey dem guide, while some Filistia pipol don take-ova Betlehem.
2SA 23:15 For dat time, David dey hongry for wota so e sey, “How I wish somebody fit bring wota kom give mi make I drink from di well wey dey near di gate for Betlehem!”
2SA 23:16 Di three sojas wey get pawa well-well kon force demsef pass Filistia pipol kamp and dem draw wota from di well kon go give David. But e nor gri drink am; instead, e pour am as ofrin for God
2SA 23:17 kon sey, “Oga God, I nor fit drink dis wota! E go bi like sey I dey drink dis pipol blood wey risk dia life!” So e nor gri drink am.
2SA 23:18 Joab broda, Abishai wey dia mama na Zeruaya, na leader for di three. E use en spear take fight against three hundred men kon kill dem and en name dey famous among di three.
2SA 23:19 Na-im dem know pass among “Di Thirty” and e bi dia leader, but e nor dey popula rish “Di Three.”
2SA 23:20 Benaya, wey bi Jehoiada pikin, wey kom from Kabzeel, na anoda popula soja. E do many strong tins kon kill two men among Moab strong sojas. One day, e still waka enter one pit go kill lion.
2SA 23:21 One day, Benaya attack and kill one Egypt man wey tall well-well and hold spear for hand. E use di man spear take kill-am.
2SA 23:22 Dat na some of di tins wey Benaya wey bi one among “Di Thirty” do.
2SA 23:23 E get pawa well-well, but e nor popula rish “Di Three.” David make am leader among en bodyguards.
2SA 23:24 Odas for “Di Thirty” na Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin, wey kom from Betlehem;
2SA 23:25 Shammah and Elika wey bi Harod pipol;
2SA 23:26 Helez wey bi Paltite pesin; Ira wey bi Ikkesh pesin and e kom from Tekoa;
2SA 23:27 Abiezer wey kom from Anatot; Mebunnai wey bi Hushah pesin;
2SA 23:28 Zalmon wey bi Ahohi pesin; Maharai wey bi Netofat pesin;
2SA 23:29 Heled wey bi Baanah pikin wey kom from Netofat; Ittai wey bi Ribai pikin wey kom from Gibeah for Benjamin tribe;
2SA 23:30 Benaya wey bi Piraton pesin; Hiddayi wey kom from Wadis for Gaash;
2SA 23:31 Abi-Albon wey bi Arbat pesin; Azmavet wey kom from Barhum,
2SA 23:32 Eliahba wey bi Shaalbon pesin and na Jashen born am Jonatan wey bi;
2SA 23:33 Shammah from Harar pikin; Ahiam wey bi Sharar pikin from Harar,
2SA 23:34 Elifelet, Ahasbai pikin wey kom from Maakat; Eliam wey bi Ahitofel pikin from Gilo;
2SA 23:35 Hezro from Karmel; Paarai from Arb,
2SA 23:36 Igal, Natan pikin wey kom from Zobah; Bani from Gad;
2SA 23:37 Zelek wey kom from Ammon, Naharai from Beerot, na-im dey karry Joab wey bi Zeruaya pikin swod and spear;
2SA 23:38 Ira and Gareb wey kom from Jattir
2SA 23:39 and Uriaya wey bi Hit pesin. All of dem na thirty-seven.
2SA 24:1 God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”
2SA 24:2 So David orda Joab wey bi di sojas oga, “Make yu go round Israel tribe with yor ofisas; from one end to anoda for di kountry kon kount di pipol. I won know how dem plenty rish.”
2SA 24:3 But Joab ansa di king, “My king, make di Oga wey bi yor God make dem plenty hundred times pass as dem bi naw and yu go leave long kon si wen E go do am, but wetin make di king won kount di pipol?”
2SA 24:4 But di king make Joab and en ofisas obey en kommand, den dem komot go kount Israel pipol.
2SA 24:5 Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and
2SA 24:6 from der, dem kon go Gilead and Kadesh for Het aria. Den dem go Dan and from Dan, dem kon go west for Sidon side.
2SA 24:7 Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.
2SA 24:8 So wen dem don waka for nine monts and twenty days, dem kon kom back to Jerusalem, bikos dem don travel round di kountry.
2SA 24:9 Dem tell di king about all di men wey fit do soja work and dem bi 800,000 from Israel and 500,000 from Judah.
2SA 24:10 But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
2SA 24:11 Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem
2SA 24:12 and I go do anytin wey e choose.” Wen David wake-up di next day,
2SA 24:13 Gad go meet and tell am wetin God tok, so e kon ask, “Wish one yu wont make God do? Three years wey honga go dey di land; three monts wey una go take run from una enemies or three days wey bad sickness go dey yor land? Naw, make yu tink am kon tell mi di ansa wey I go-go give God.”
2SA 24:14 David ansa, “I dey for bad kondishon, but I nor wont make men ponish mi, instead make only God ponish us, bikos E get mesi.”
2SA 24:15 So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel.
2SA 24:16 Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.
2SA 24:17 David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
2SA 24:18 Dat day, Profet Gad go meet David kon tell am, “Make yu go Araunah farm kon build altar for der for di Oga yor God.”
2SA 24:19 David obey and e do evritin wey Profet Gad tell am.
2SA 24:20 Wen Araunah look kon si di king and en ofisas dey kom meet am, e liedan for groun for David front
2SA 24:21 kon ask, “My king, why yu kom here?” David ansa, “I kom buy yor farm make I for build altar put for God, so dat di sickness go stop.”
2SA 24:22 But Araunah ansa, “My king, make yu take am! Make yu use am do anytin wey yu like kon burn dis melu give God for di altar. Make yu use dia yoke and dis firewood for di ofrin.”
2SA 24:23 Araunah give di king evritin kon sey, “Make di Oga wey bi yor God asept yor ofrin.”
2SA 24:24 But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.” So e buy di farm and di melu for fifty silva koins.
2SA 24:25 Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.
1KI 1:1 Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am.
1KI 1:2 So en ofisas tell am, “My king, make wi find one yong woman wey neva sleep with man before. E go dey sleep near yu and yor body go dey warm.”
1KI 1:3 Dem find evriwhere for Israel and dem si one fine girl kon karry am go meet di king, Di girl kom from Shunem and en name na Abishag.
1KI 1:4 Di girl fine well-well, e dey kare and serve di king, but David nor sleep with am.
1KI 1:5 For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.
1KI 1:6 (David neva even ask or korrect am wons sey, “Wetin make yu dey bihave like dis?” Adonijah na very fine man too and naim dem born follow Absalom.)
1KI 1:7 E follow Joab wey Zeruaya bi en mama and Abiatar wey bi di priest plan and dem kon gri to support am.
1KI 1:8 But Zadok wey bi priest, Benaya wey bi Jehoiada pikin, Natan di profet, Shimei, Rei and David bodyguard, nor gri support am.
1KI 1:9 One day wey Adonijah go sakrifice sheep and fat melu to God on-top di Snake Stone (Zohelet Stone) near En-Rogel wotaside, e invite di oda shidren wey David born and di ofisas wey kom from Judah make dem kom di sakrifice,
1KI 1:10 but e nor invite Solomon wey bi en half broda, Natan di profet or Benaya and di king bodyguards.
1KI 1:11 Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am!
1KI 1:12 If yu won save yor life and Solomon own, I go advise yu sey,
1KI 1:13 make yu go meet David kon ask am, ‘My king, yu nor promise mi sey, Solomon my pikin go bi king? How kom Adonijah kon bi king naw?’ ”
1KI 1:14 Natan still sey, “As yu still dey tok to di king, I go kom inside kon tell am sey na true yu dey tok.”
1KI 1:15 So Batsheba go meet David for en room, e don old well-well and di girl Abishag wey kom from Shunem dey kare for am.
1KI 1:16 Batsheba bow for di king front and di king kon ask am, “Wetin yu wont?”
1KI 1:17 E ansa, “My king, yu use di Oga yor God name take promise mi sey ‘Yor pikin, Solomon go bi king afta mi and e go sidan for my throne.’
1KI 1:18 But Adonijah don make ensef king and yu nor know anytin about am.
1KI 1:19 E don use many goat, sheep and fat melu take do sakrifice and e invite Abiatar di priest, yor shidren and Joab wey dey kommand yor sojas, but e nor invite Solomon.
1KI 1:20 My king, Israel pipol dey wait make yu tell dem who go bi king afta yu.
1KI 1:21 If yu nor tok, as yu just die, dem go trit mi and my pikin Solomon, like bad pipol.”
1KI 1:22 As Solomon mama still dey tok to di king, Natan kon kom di house.
1KI 1:23 Dem tell di king sey, “Natan wey bi profet dey der.” Natan enter di room kon bow for di king front.
1KI 1:24 Natan sey, “My king, yu don announce sey na Adonijah go bi king afta yu?
1KI 1:25 Bikos, today, e don use many sheep, goat and fat melu take do sakrifice. E invite all yor shidren, Joab wey dey kommand yor sojas and Priest Abiatar and as wi dey tok so, dem dey do party dey shaut sey, ‘Adonijah, yu bi king! Make yu live forever!’
1KI 1:26 But e nor invite mi, Priest Zadok, Benaya and yor savant Solomon.
1KI 1:27 My oga know all dis tins and yu nor even tell yor ofisas who go bi king afta yu?”
1KI 1:28 David ansa, “Make yu tell Batsheba make e kom inside,” so di woman kom kon stand for di king front.
1KI 1:29 Den e tell am, “God wey save mi from all my trobols, I use en name take promise yu
1KI 1:30 sey, I go keep di promise wey I make with Israel God name sey, na Solomon go bi king afta mi.”
1KI 1:31 Batsheba bow kon sey, “Make my oga, di king live forever!”
1KI 1:32 Den David sey make dem koll Zadok, Natan and Benaya. Wen dem enter,
1KI 1:33 e tell dem, “Make una take my ofisas follow body; make Solomon my pikin ride my horse, den una escort am go Gihon wotaside,
1KI 1:34 where Natan and Zadok go anoint am as Israel king. Den make una blow di trumpet kon shaut, ‘Solomon, yu bi king! Make yu live forever!’
1KI 1:35 Make una follow am kom back kon sidan for my throne. E go bi king afta mi, bikos naim I don choose to rule Israel and Judah pipol.”
1KI 1:36 Benaya ansa, “I go do as yu tok and make God wey bi yor God asept am as king!
1KI 1:37 As Oga God don dey with awa king, make E dey with Solomon and make E prosper am, pass yu.”
1KI 1:38 So Zadok di priest, Natan di profet, Benaya and di royal bodyguards kon put Solomon for David horse and dem escort am go Gihon wotaside.
1KI 1:39 Zadok karry di olive oil wey e bring from Tabanako kon use am anoint Solomon. Dem blow di trumpet and all di pipol kon shaut, “Solomon, na yu bi king! Make yu live forever!”
1KI 1:40 Den all of dem follow am go back dey happy, dey shaut, blow flute, dey make plenty nois and di groun kon dey shake.
1KI 1:41 As Adonijah with all di pipol wey e invite dey finish dia party, dem kon hear di nois. Wen Joab hear di trumpet, e ask, “Wetin dey bring dat kind nois for di town?”
1KI 1:42 Before e tok finish, Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon enter. Adonijah sey, “Make yu kom inside. Yu bi good man, na betta news yu go dey bring so.”
1KI 1:43 Jonatan ansa, “Nor bi as yu wont am, bikos David don make Solomon king.
1KI 1:44 E send Zadok, Natan, Benaya and di palis bodyguard make dem put am for en horse kon escort am,
1KI 1:45 den Zadok and Natan anoint am for Gihon wotaside as king. So pipol enter town bigin shaut dey happy and na dat bi di nois wey yu dey hear so.
1KI 1:46 Na Solomon bi king naw.
1KI 1:47 Di one wey worse pass bi sey, all di ofisas go meet David kon tell am, ‘God go make Solomon dey great pass yu and en reign go pass yor own ten times.’ Den King David bow woship God from en bed
1KI 1:48 kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”
1KI 1:49 Den doz wey Adonijah invite kon dey fear and all of dem stand up bigin go one-by-one.
1KI 1:50 Adonijah kon dey fear Solomon so e go di tent for God present kon hold di horn wey dey di altar.
1KI 1:51 Dem tell Solomon sey, bikos Adonijah dey fear am, e go hold di horn wey dey di altar kon sey, “I wont make Solomon swear for evribody present sey e nor go kill mi.”
1KI 1:52 Solomon ansa, “If e go respet mi, I nor go even tosh one hair for en head, but if e nor respet mi, I go kill-am.”
1KI 1:53 Solomon send dem go koll Adonijah from di altar. Adonijah go meet am kon bow for en front, so di king kon tell am sey make e dey go en house.
1KI 2:1 Wen David won die, e koll en pikin Solomon kon advise am sey:
1KI 2:2 “I go soon die, so make yor heart strong
1KI 2:3 kon do evritin wey di Oga yor God kommand yu. Make yu obey en laws and kommand, just as Moses rite dem, so dat yu go prosper for evriwhere and anytin wey yu dey do.
1KI 2:4 If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
1KI 2:5 “E still remain one tin: yu remember wetin Joab do mi wen e kill two kommander for Israel sojas, Abner wey bi Ner pikin and Amasa wey bi Jeta pikin. E pritend kill dem like sey dem dey fight and dat time peace dey evriwhere, kon stain en belt and sandals with innocent blood.
1KI 2:6 Yu know wetin yu go do, make yu sofa am well-well until e die.
1KI 2:7 “But make yu dey kind to Barzillai shidren wey kom from Gilead kon kare for dem, bikos dem dey kind to mi wen I dey run from Absalom, yor broda.
1KI 2:8 “E still get Shimei wey bi Gera pikin, wey kom from Bahurim town for Benjamin tribe. E curse mi well-well di day wey I go Mahanaim, but wen e si mi for Jordan River, I use God name take promise am sey I nor go kill-am.
1KI 2:9 But naw, nor si am as innocent pesin. Yu bi man wey get wisdom, yu know wetin yu go do am. Make sure sey dem kill-am.”
1KI 2:10 David die and dem beri am for David Town.
1KI 2:11 E rule Israel for forty years kon rule seven years from Hebron and thirty-three years from Jerusalem.
1KI 2:12 Solomon take-ova from en papa as king and God make en kingdom strong.
1KI 2:13 Den Adonijah, wey en mama na Haggit, go meet Batsheba, Solomon mama and di woman ask am, “Dis na betta visit so?” Adonijah ansa, “Yes! Na betta visit.”
1KI 2:14 Den Adonijah sey, “E get wetin I won ask yu.” Batsheba ask am, “Wetin bi dat?”
1KI 2:15 E ansa, “Yu know sey di kingdom suppose bi my own and evribody for Israel si mi as king. But na my broda kon bi king, bikos na so God wont make e bi.
1KI 2:16 So naw, e get one tin wey I won ask for, abeg make yu agri.”
1KI 2:17 Batsheba ask, “Na wetin e bi?” E ansa, “Abeg, make yu help mi tell King Solomon make e allow mi marry Abishag, dat girl wey kom from Shunem.”
1KI 2:18 Di woman ansa, “Okay, I go tok to di king for yu.”
1KI 2:19 Batsheba go meet di king, make e for tell am wetin Adonijah tok. Di king stand up, bow greet en mama, den e sidan for en throne kon bring anoda chair for en mama make e for sidan for en rite side.
1KI 2:20 En mama sey, “E get one small tin wey I won ask from yu. Abeg, make yu agri.” Solomon ask, “Mama! Make yu ask and I nor go refuse.”
1KI 2:21 Batsheba ansa, “Make yu allow Adonijah marry Abishag as en wife.”
1KI 2:22 Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”
1KI 2:23 Den Solomon swear with God name sey, “Make God ponish mi if I nor make Adonijah pay with en life for dis tin wey e ask for!
1KI 2:24 God don already plant mi put for David, my papa throne; E don keep en promise and E don give mi and my shidren-shidren di kingdom. I use God name take swear sey, today-today, Adonijah must die!”
1KI 2:25 So, Solomon orda Benaya wey bi Jehoiada pikin sey make e go kill Adonijah.
1KI 2:26 Den Solomon tell Priest Abiatar, “Make yu dey go yor kountry for Anatot. Yu suppose to die, but I nor go kill yu naw, bikos na yu kare for di Kovenant Box wen yu dey with David my papa and yu follow am face all en trobols.”
1KI 2:27 Den Solomon sey make Abiatar nor bi God priest again. So, wetin God tok for Shiloh about Eli and en shidren-shidren kon happen.
1KI 2:28 Joab hear wetin happen (bikos na Adonijah e bin dey support, even doh e nor support Absalom). So e run go di tent for God present kon hold di altar horn.
1KI 2:29 Wen King Solomon hear sey Joab run go di tent go stand near di altar, e send Benaya wey bi Jehoiada pikin, make e go kill-am for der.
1KI 2:30 Benaya go di tent kon tell Joab, “Di king sey make yu kom out.” Joab ansa, “No! I go die for here!” Benaya go meet di king kon tell am wetin Joab tok.
1KI 2:31 So, Solomon ansa, “Make yu do as e tok. Kill and beri am, so dat dem nor go hold mi, yu or any oda David pikin for wetin Joab do wen e kill innocent pipol.
1KI 2:32 God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.
1KI 2:33 Dia blood go dey for Joab and en shidren-shidren head forever. But God go make David and shidren-shidren prosper for en throne forever.”
1KI 2:34 So Benaya go Tabanako kon kill and beri Joab for en house wey dey di wildaness.
1KI 2:35 Di king make Benaya di sojas oga for Joab place, den e put Zadok as priest for Abiatar place.
1KI 2:36 Den di king send message go meet Shimei, “Make yu build house for yorsef here for Jerusalem kon stay and make yu nor komot di town.
1KI 2:37 If yu ever pass Kidron Valley, yu go die and di blame go dey yor own head.”
1KI 2:38 Shimei ansa, “Okay my king, I go do wetin yu tok,” So Shimei stay for Jerusalem for long time.
1KI 2:39 Afta three years, two of Shimei slave kon run go meet Maaka pikin wey bi King Akish for Gat. Wen Shimei hear sey dem dey for Gat,
1KI 2:40 e enter en donkey kon go find en slaves wey dey with King Akish. E si dem kon bring dem kom house back.
1KI 2:41 Wen Solomon hear wetin Shimei do,
1KI 2:42 e sey make dem go koll am kom, den e tell am, “Shebi I use God name take tell yu make yu nor komot from Jerusalem. And I warn yu sey, if yu try am, yu go die. Yu agri kon sey yu go obey mi?
1KI 2:43 Wetin make yu nor keep yor promise? Why yu disobey my kommand?
1KI 2:44 “Yu know all di wrong tins wey yu do David, my papa. Naw, God go ponish yu.
1KI 2:45 But E go bless mi kon guide David kingdom forever.”
1KI 2:46 Den di king orda Benaya and e kill Shimei. So, Solomon kon dey kontrol evriwhere.
1KI 3:1 Solomon kon tell King Fero for Egypt sey e won marry en dota. E marry and take di woman go David Town until e build en palis and di temple kon fence Jerusalem round.
1KI 3:2 Dat time, dem neva build temple for God, so di pipol still dey sakrifice for difren-difren altar.
1KI 3:3 Solomon love God and e follow wetin en papa David, tok. But e still dey kill animal as ofrin for difren altar.
1KI 3:4 One day, Solomon go do sakrifice for Gibeon, bikos di altar wey dey der, fine well-well. E don rish 1,000 times wen Solomon don burn ofrin give God for der.
1KI 3:5 One nite wen Solomon dey Gibeon town, God kon appear and ask am for dream sey, “Solomon, make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”
1KI 3:6 Solomon ansa, “Yu show great love to David my papa wey bi yor savant and e dey good, dey respet and always dey honor Yu. Yu still show am yor great love wey nor dey end, wen Yu make one of en pikin king afta am.
1KI 3:7 “My Oga God, even doh I still dey yong and I nor sabi rule, Yu make mi take-ova from my papa as king.
1KI 3:8 I dey here with doz wey Yu choose as yor own; pipol wey nobody fit kount.
1KI 3:9 So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”
1KI 3:10 God happy well-well, bikos of wetin Solomon ask for,
1KI 3:11 so E tell am, “Bikos yu don ask for wisdom to rule well, instead of long life, propaty or make yor enemies die,
1KI 3:12 I go do wetin yu ask. I go give yu wisdom and undastandin wey pass di ones wey anybody don get before or go get afta yu.
1KI 3:13 Tins wey yu nor ask for, I go still give dem to yu. Till yu go die, yor propaty and respet go plenty pass di ones wey any king go ever get.
1KI 3:14 And if yu obey and keep my laws and kommand, just as David yor papa do, I go give yu long life.”
1KI 3:15 Wen Solomon wake-up, e kon undastand sey God don tok to am for dream. Den e go Jerusalem go stand for God Kovenant Box front kon offa burn and fellowship ofrin give God. Afta, e do party for all en ofisas.
1KI 3:16 One day, two wimen wey dey do ashawo work kom judge dia matter give Solomon.
1KI 3:17 One of dem sey, “My king, mi and dis woman dey stay for di same house. I born boy pikin as wi dey stay togeda.
1KI 3:18 Two days afta I don born my pikin, dis woman kon still born boy. Na only two of us dey stay di house.
1KI 3:19 “Den one nite as e dey sleep, e kon roll press en pikin and di pikin kon die.
1KI 3:20 E stand up for nite and wen e si sey I dey sleep, e karry my pikin go en bed kon put en pikin wey don die for my bed.
1KI 3:21 Di next morning wen I wake-up make I feed my pikin, I si sey e don die, but as I look am well-well, I kon si sey nor bi my pikin bi dat.”
1KI 3:22 But di oda woman ansa, “No! Di pikin wey dey alive, na my own and na en get di one wey don die!” Di first woman still sey, “Na lie yu dey lie! Di one wey don die na yor own and na mi get di pikin wey dey alive!” So dem kon dey drag for di king front.
1KI 3:23 Den Solomon sey, “Una two sey di pikin wey dey life na una own, while di one wey don die na di oda pesin own.”
1KI 3:24 So Solomon kon sey make dem bring swod and wen dem bring am,
1KI 3:25 e kon tell di savant, “Divide di pikin wey dey alive into two kon share am give dis wimen.”
1KI 3:26 Den di pikin real mama kon tell di king with pain for en heart sey, “My King! Abeg, instead make yu kill di pikin, make yu gi-am to di oda woman.” But di oda one ansa, “My king! Nor give di pikin to any of us, but make yu just divide am.”
1KI 3:27 Den Solomon tell di savant, “Nor kill di pikin again, but gi-am to di first woman, bikos na en bi di real mama.”
1KI 3:28 Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
1KI 4:1 King Solomon rule evriwhere for Israel land.
1KI 4:2 Dis na en ofisas: Azaraya wey bi priest and na Zadok bi en papa.
1KI 4:3 Elihoref and Ahijah wey bi Shisha shidren na dem bi seketry for di kourt. Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, na en dey keep rekord.
1KI 4:4 Na Jehoiada pikin, Benaya bi di sojas oga. Na Zadok and Abiatar bi priest.
1KI 4:5 Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.
1KI 4:6 Ahishar dey kare for di palis savants, while Adoniram wey Abda born, dey kare for doz wey dey do hard work.
1KI 4:7 Solomon put twelf men as govnor for Israel. Na dem dey provide food for di king, en family and di difren aria. Each of di twelf men dey handle each mont for di year.
1KI 4:8 Dis na di ofisas and di district wey dem dey kare for: Ben Hur dey kare for Efraim hill kountries;
1KI 4:9 Ben-Deka dey kare for Makas, Shaalbim, Bet-Shemesh, Elon and Bet-Hanan town.
1KI 4:10 Ben-Hesed dey kare for Arubbot, Soko and all di aria for Hefa.
1KI 4:11 Ben-Abinadab wey marry Solomon dota Tafat, dey kare for all di aria for Dor.
1KI 4:12 Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.
1KI 4:13 Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
1KI 4:14 Ahinadab wey bi Iddo pikin dey kare for Mahanaim aria.
1KI 4:15 Ahimaaz wey still marry Basemat wey bi King Solomon dota, dey kare for Naftali aria.
1KI 4:16 Baana wey bi Hushai pikin dey kare for Asher aria and Bealot town.
1KI 4:17 Jehoshafat wey bi Paruah pikin, dey kare for Issakar aria.
1KI 4:18 Ela pikin wey bi Shimei dey kare for Benjamin aria.
1KI 4:19 Gibeah wey Uri born, naim dey kare for Gilead wey King Sihon from Amor and King Og for Bashan bin dey rule. Apart from dis twelf, e still get one govnor wey dey rule di whole land.
1KI 4:20 Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy.
1KI 4:21 Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.
1KI 4:22 Di tins wey Solomon nid evriday, na 150 bag of fine flower and three hundred bag of food,
1KI 4:23 den 10 big melu, 20,000 fat melu and 100 sheep with deer, gazelle and bird wey dem feed well.
1KI 4:24 Solomon rule di west and evriwhere for Eufrates River. From Tifsah for Eufrates side go rish di west for Gaza town. All Eufrates king dey under am and e dey make peace with all di kountries wey near am.
1KI 4:25 Judah and Israel pipol get peace thru-out di time wey Solomon dey rule and all di family get dia own grapevines and fig trees.
1KI 4:26 Solomon get 4,000 house for en shariot and 12,000 horse.
1KI 4:27 Na di twelf govnor dey bring di food wey Solomon and all di pipol for di palis go chop. Each one, for each mont.
1KI 4:28 Each govnor dey bring en own barley and straw for di shariot and animals wey dey work kom di propa place wey dem suppose take am go.
1KI 4:29 God give Solomon betta wisdom, sense and en undastandin big well-well.
1KI 4:30 Solomon get sense pass di wise men for east and for Egypt.
1KI 4:31 Na-im wise pass among all men. E wise pass Etan wey kom from Ezra and Heman, Kalkol, Darda wey bi Mahol shidren. So pipol kon dey tok about Solomon wisdom for all di kountries wey dey near Israel
1KI 4:32 E rite 3,000 parabol and di songs wey e rite, pass 1,000.
1KI 4:33 E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish.
1KI 4:34 All di kings for di world hear about en wisdom, so dem kon send pipol go listin to am.
1KI 5:1 King Hiram for Tyre, na David friend, so wen e hear sey Solomon don bi king afta en papa, David, e kon send some pipol go meet am.
1KI 5:2 Solomon send dis message go meet King Hiram,
1KI 5:3 “Yu know sey, bikos of di war wey David my papa dey fight with all en enemies, e nor fit build temple where dem go for dey woship di Oga wey bi en God, until God gi-am viktory ova all en enemies.
1KI 5:4 But naw, God don give mi peace for evriwhere. I nor get any enemy and I nor dey fear sey pipol go won attack mi.
1KI 5:5 God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.
1KI 5:6 So make yu send yor men go Lebanon go kut cedar wood for mi. My men go work with dem and I go pay yor men any prize wey yu tok. Yu know sey my men nor sabi kut trees like yor men.”
1KI 5:7 Hiram happy wen dem gi-am Solomon message so e kon sey, “Make wi praiz God today wey give David dat kind pikin as king ova dis strong nashon!”
1KI 5:8 Den Hiram send Solomon dis message sey, “Dem don give mi yor message and I ready to do wetin yu wont. I go provide di cedar wood and di pine trees wey yu wont.
1KI 5:9 My men go bring di woods from Lebanon kom di river kon tie dem togeda and float dem kom di place wey yu choose. Den, my men go luz dem and yor men go karry dem go. But I go like make yu give my men food.”
1KI 5:10 So Hiram give Solomon all di cedar wood and pine tree wey e wont
1KI 5:11 and Solomon dey give Hiram 100,000 bucket for wheat and 110,000 gallons for pure olive oil evry year make e take feed en men.
1KI 5:12 God keep en promise kon give Solomon wisdom. Peace dey between Hiram and Solomon and dem make agriment with diasef.
1KI 5:13 Solomon bring 30,000 men from evriwhere for Israel make dem do di work
1KI 5:14 and e sey make Adoniram kare for dem. E divide dem into three group. 10,000 men dey one group and each group dey spend one mont for Lebanon and two monts for house.
1KI 5:15 Solomon still get 80,000 men for di mountin side wey dey kut stones and 70,000 men wey dey karry di stones.
1KI 5:16 E still put 3,300 men for front make dem dey supavise di work.
1KI 5:17 Just as Solomon tok, dem kon kut fine big stones wey dem go take build di temple foundashon.
1KI 5:18 So, King Solomon men, King Hiram men and di men from Gebal town kon make di stones and timba wey dem go take build di temple.
1KI 6:1 Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
1KI 6:2 Di temple long rish 90 fit kon wide rish 30 fit and e high rish 45 fit.
1KI 6:3 Di passage wey dem take dey enter di temple wide rish 30 fit and na so e long too. E still use 15 fit take long go outside.
1KI 6:4 Solomon still use frames make windows for di temple.
1KI 6:5 E build some room take join di temple walls for outside.
1KI 6:6 Di rooms for outside na three story building and di bottom floor wide rish seven and half fit, di middle floor na 9 fit while di top floor na ten and half fit. E build di room join di temple but dia timba nor enter di wall.
1KI 6:7 Dem make di stones wey dem take build di temple, from where dem for kut dem, so no hammer, axe or any oda iron make sound for di main site.
1KI 6:8 Where dem dey pass enter di down floor dey di sout-side for di temple and dem put step to take klimb go di sekond and di third floor.
1KI 6:9 So Solomon kon build di temple finish. E put ceiling wey dem make with woods and cedar boards.
1KI 6:10 E build difren rooms round di temple; dem high rish seven and half fit and e use timba join dem to di temple.
1KI 6:11 God tell Solomon,
1KI 6:12 “But for dis temple wey yu dey build, If yu obey all my laws and kommand, evritin wey I promise yor papa David, I go do dem for yu.
1KI 6:13 I go stay with my pipol Israel and I nor go ever abandon dem.”
1KI 6:14 So, Solomon kon build di temple finish.
1KI 6:15 From di groun go rish di ceiling for inside, na cedar wood dem take kover dem kon make di floor with pine wood.
1KI 6:16 Di room for inside wey dem dey koll, “Most Holy Place” na di temple back dem build am put. E long rish 30 fit and dem use cedar board take divide am from groun go rish di ceiling.
1KI 6:17 Di room wey dey front for di “Most Holy Place”, long rish 60 fit.
1KI 6:18 Dem dekorate di cedar panels with tins wey den karve and with flowers, den dem use cedar wood kover di inside, so dat dem nor go si di stones wey dey di wall.
1KI 6:19 Dem build di inside room for di temple back and dem won put God Kovenant Box for der.
1KI 6:20 As di inside room long, na so too e high rish 30 fit and dem kover evriwhere with gold. Dem kover di temple with cedar panels.
1KI 6:21 Dem kover di temple for inside with gold kon use gold shain cross and kover where dem dey pass enter.
1KI 6:22 Dem kover evriwhere for inside di temple with gold, plus di altar wey dey di “Most Holy Place.”
1KI 6:23 Dem make two creatures wey get feadas with olive wood and di creatures dey di, “Most Holy Place.” Each of di creature, tall rish fifteen fit.
1KI 6:24 Each of di first creature feada long rish seven and half fit, so di two feada na 15 fit.
1KI 6:25 Di sekond creature bi like di first one but for size and shape;
1KI 6:26 each of dem tall rish 15 fit.
1KI 6:27 Dem put dem for di two side for di “Most Holy Place.” So dia feadas wey dem spread, go tosh each oda for di room middle and di oda two feadas tosh di wall.
1KI 6:28 Na gold dem use take make di two creatures.
1KI 6:29 Dem use creatures wey dem karve with feadas, palm tree and flower, take dekorate di wall both for inside and outside.
1KI 6:30 Dem even use gold take dekorate di floor.
1KI 6:31 Na olive wood dem take make doors wey pipol go pass enter and di pila for each door, get five side.
1KI 6:32 Di two doors wey dem make with olive wood, dem karve doz creatures with feadas, palm tree and flower put kon kover dem with gold.
1KI 6:33 Like dis, dem make door-mot with olive wood for di place wey dem dey pass enter di main hall and dem get four pila for di side.
1KI 6:34 Dem still make two doors with pine wood and each door get two side wey dey fold.
1KI 6:35 Dem karve creatures with feadas, palm tree and flower take dekorate am kon kover all of dem with gold.
1KI 6:36 Dem build one kourt for di temple front kon use cedar wood and stones take make di wall.
1KI 6:37 For Ziv mont, for di fourt year wey Solomon don dey rule, naim dem lay di foundashon for God Temple.
1KI 6:38 For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.
1KI 7:1 Solomon still build palis for ensef and na thirteen years e take build am.
1KI 7:2 E koll am “Di Palis for di Lebanon Forest.” E long rish 150 fit, wide rish 75 fit and e high rish 45 fit. E get four rows wey dem make with cedar pilas and cedar wood dey on-top di pilas too.
1KI 7:3 Na cedar wood dem still use take make di roof on-top di wood wey support di pilas; dem bi forty-five wood and na fifteen dey each row.
1KI 7:4 For each side for di wall, na three-three windows dey each row.
1KI 7:5 Evriwhere wey dem dey pass enter, get four side and dem arrange dem into three set.
1KI 7:6 Di Passage Hall long and wide rish 75 and 45 fit. E get korridor and pila and roof dey di korridor front.
1KI 7:7 Solomon still make one throne room kon koll am “Judgement Hall” and na der e for dey judge kase. Dem make am with cedar wood from groun go rish di roof.
1KI 7:8 Na so too dem take make di palis where Solomon dey stay. E still build one palis like en own kon gi-am to Fero dota wey e marry.
1KI 7:9 Na di best stones dem take build and karve all dis tins kon kut dem with saw; from di roof foundashon and from di outside go rish di great kourtyard.
1KI 7:10 Na betta-betta stones dem take make di foundashon. Some long rish twelf and odas, na fifteen fit.
1KI 7:11 On-top di foundashon, di best stones wey dem karve for di rite side, na-im dem use with di cedar wood.
1KI 7:12 Around di great kourtyard, na three row of betta stones and one row of cedar wood dey der like di kourt for inside God Temple and di palis hall.
1KI 7:13 King Solomon sey make dem go koll Hiram kom from Tyre.
1KI 7:14 Na one woman from Naftali wey en husband don die, born am and en papa na kraft man wey bin dey work with bronze for Tyre. E get wisdom to take make any kind tin with bronze. E go meet King Solomon kon do all di work wey dem gi-am.
1KI 7:15 Hiram make two bronze pila; each pila tall rish 27 fit and wide rish 18 fit.
1KI 7:16 E still make bronze top for di pilas and each one high rish seven and half fit.
1KI 7:17 Na shain wey dem weave dem take dekorate di top
1KI 7:18 and di two rows with di bronze stones.
1KI 7:19 Dem design di top like lily leaf and e tall rish 6 fit
1KI 7:20 kon put am for one round place wey high pass where dem design with shain. For di main top, na 200 betta stones dey round one pila.
1KI 7:21 Hiram put dis two bronze pila for where dem dey pass enter di temple. Di one wey dey di sout-side na, “Jakin”, while di one for nort na, “Boaz.”
1KI 7:22 Di pila top bi like lily. So dem kon build di pila finish.
1KI 7:23 Hiram still make di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” E deep rish seven and half fit kon long and wide rish 15 and 45 fit.
1KI 7:24 Di basin korna for outside get two bronze iron and na one block dem take build am with di basin.
1KI 7:25 Di basin dey on-top twelf melu. Three face di nort; three face di west, three face di sout and three face di east. Di Sea dey on-top of dem and all of dem face outside.
1KI 7:26 Di basin tick rish three inches. En rim bi like cup own wey curve out like lily and di basin fit kontain 12,000 gallon of wota.
1KI 7:27 Hiram still make ten bronze stand wey dem fit move. Each stand tall and wide rish 6 fit and dem high rish four and half fit.
1KI 7:28 Dem make dem with panel kon set dem with frame,
1KI 7:29 den dem draw lion, bulls and di creatures wey get feada for di body. Dem still draw dem put for di frames for up and under di lion and di melu, den dem rite sometin put.
1KI 7:30 Each of di four stand get four bronze wheel with bronze axles. Dem put bronze for di four korna wey go support di basin, den rite sometin take dekorate di wood wey support am.
1KI 7:31 Di basin get one round frame. Di kart tall rish 18 inches kon deep rish 7 inches. Dem still karve tins round am.
1KI 7:32 Di wheel high rish 25 inches and dem dey under di panel, but di axles and di kart na di same.
1KI 7:33 Di wheel bi like shariot own and na bronze dem take make dia axles, rim, spokes and hub.
1KI 7:34 All di karts get four support for under and dem bi di same with di karts.
1KI 7:35 Nine inches band dey round di top for each kart, dem dey support di kart and di panel na di same with di kart.
1KI 7:36 Hiram use animals wey get feadas, lion and palm trees, take dekorate di wood wey support am, di panel and anywhere space dey, den e rite full dia body.
1KI 7:37 Na so dem take make all di kart. All of dem resemble and dem bi di same size and shape.
1KI 7:38 Hiram still make ten basin for each kart. One basin wide rish 6 fit wey go kontain 200 gallon of wota.
1KI 7:39 E put five kart for di sout-side for di temple and di oda five dey di nort side, den kon put di tank for di korna wey face sout and west korna.
1KI 7:40 Hiram still make shovel, basin and plates. E finish all di work wey Solomon gi-am for God temple.
1KI 7:41 Na wetin Hiram make bi dis: di two pilas; di two top for di pilas wey bi like bowl; di art work wey dey di bowl on-top di two pilas;
1KI 7:42 di 400 fine stones wey dem design for di art work for di two pilas; all di art work with dia two lines of fine stones on-top di bowl for di pilas;
1KI 7:43 di ten stands wey dey move with di ten basins;
1KI 7:44 di big bronze basin wey dem dey koll, “Di Sea” with twelf melu wey dey under am;
1KI 7:45 di pots, shovel and bowls. So, all di tins wey Solomon sey make Hiram make for di temple, na bronze wey dem polish dem take make dem.
1KI 7:46 Between Sukkot and Zaretan borda for Jordan, na der di king for make all dis tins.
1KI 7:47 Solomon nor weigh all di bronze tins, bikos dem too plenty. So, dem nor know how dem heavy rish.
1KI 7:48 Na gold Solomon take design di temple, di altar, di tabol wey dem dey put God bread,
1KI 7:49 di ten lampstand wey dey for di Most Holy Place wey five face sout and five face nort; di flowers, lamps and tongs.
1KI 7:50 Di cups, lamp tins, bowls, plate for incense and di pans wey dem take dey karry shako; di Most Holy Place door handle and di doors wey dey outside di temple. Na gold dem take make all dis tins.
1KI 7:51 Wen King Solomon don finish di temple work, e kon put all di tins wey David en papa dedikate give God, inside di temple store room: di silva, gold and all di oda tins.
1KI 8:1 Solomon koll all di leaders for Israel tribe and villages kon tell dem, “Make una karry God Kovenant Box go di temple for Zion wey bi David Town.”
1KI 8:2 Wen dem dey do Shelta Feast for Etanim mont (wey bi di sevent mont), all of dem kon gada,
1KI 8:3 den di priest lift di Kovenant Box
1KI 8:4 kon karry am go put for di temple. Levi pipol and di priest still karry di tent wey God for dey meet di pipol, with all di oda tins, go di temple.
1KI 8:5 Solomon and Israel pipol gada for di Kovenant Box front kon sakrifice plenty sheep and melu.
1KI 8:6 Den di priest karry di Kovenant Box enter di temple kon put am for di Most Holy Place; under di creatures wey get feadas.
1KI 8:7 Di creature feadas kover di pole wey dem take karry am.
1KI 8:8 Na only di pesin wey sidan for di Most Holy Place front, fit si di pole end and nobody fit si dem from any oda place. Di poles still dey der till today.
1KI 8:9 Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.
1KI 8:10 As di priests dey komot from di temple, kloud kon kover di temple.
1KI 8:11 Di priest nor fit do anytin again, bikos God present don full di temple.
1KI 8:12 Den Solomon kon pray, “Oga God, Yu sey Yu go stay for darkness.
1KI 8:13 Naw! I don build big temple for Yu, place wey Yu fit stay forever.”
1KI 8:14 As di pipol stand for der, Solomon turn face dem kon bless dem with God name.
1KI 8:15 E sey, “Di Oga wey bi Israel pipol God, make all di praiz bi en own! E don do wetin E promise David my papa, wen E tell am sey,
1KI 8:16 ‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ”
1KI 8:17 Solomon still sey, “David my papa plan sey e go build temple where dem go for woship di Oga wey bi Israel pipol God,
1KI 8:18 but God tell am, ‘Yu do well as yu won build temple for mi,
1KI 8:19 but yu nor go ever build am. Na yor own pikin go build my temple.’
1KI 8:20 And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God.
1KI 8:21 I don still make place for di temple, where dem go keep di Kovenant Box and di stone wey dem rite di kovenant put, wey God make with awa grand-grand papa wen E bring dem kom out from Egypt, dey inside.”
1KI 8:22 Den, for di pipol present, Solomon go stand for di altar front, raiz en hand
1KI 8:23 kon pray, “Di Oga wey bi Israel pipol God; e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for eart! Yu do wetin Yu promise yor pipol kon show dem yor love, bikos dem obey Yu with dia whole heart.
1KI 8:24 Today, Yu don do wetin Yu promise David my papa. Yu don do evry word wey Yu tok.
1KI 8:25 And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu.
1KI 8:26 Naw, my Oga wey bi Israel God, make Yu do evritin wey Yu promise David my papa wey bi yor savant.
1KI 8:27 My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?
1KI 8:28 Oga wey bi my God; I bi yor savant. Make Yu listin to my prayer kon do evritin wey I go ask Yu today.
1KI 8:29 Make Yu look dis temple both for day and for nite; di place where Yu choose sey make dem for dey woship Yu.
1KI 8:30 Make Yu hear mi anytime wey I face dis temple dey pray. Make Yu hear and forgive us from where Yu dey for heaven.
1KI 8:31 If dem tok sey pesin do anoda pesin bad and dem bring am kom yor altar for dis temple, den e swear sey e nor do am,
1KI 8:32 my Oga God, make Yu listin from heaven, den kon judge yor savants. Make Yu ponish di one wey do bad as e fit am kon free di one wey dey rite.
1KI 8:33 Wen Israel pipol enemies win dem, bikos dem sin against Yu and if dem turn to Yu for dis temple kon sey, ‘Papa forgive us’,
1KI 8:34 make Yu listin to dem from heaven. Make Yu forgive dem kon bring dem back to di land wey Yu promise dia grand-grand papa.
1KI 8:35 If Yu hold di rain, bikos yor pipol sin against Yu, wons dem turn from sin kom meet Yu kon pray to Yu for dis temple,
1KI 8:36 make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.
1KI 8:37 Wen honga dey di land; sickness or plants don spoil, bikos of strong wind, plenty lokust or wen enemies attack yor pipol; or sickness and diziz katch dem,
1KI 8:38 make Yu listin to dia prayers and if anybody wey dey face pain for Israel, stresh en hand pray for dis temple,
1KI 8:39 make Yu hear dia prayer and listin to dem from where Yu dey for heaven. Make Yu forgive and help dem. Na only Yu know wetin human being dey tink. Make Yu ponish or bless anybody as e fit am,
1KI 8:40 so dat yor pipol go always obey Yu as long as dem dey dis land wey Yu give dia grand-grand papa.
1KI 8:41 Wen pesin from anoda land hear di big-big tins wey Yu do for yor pipol,
1KI 8:42 dem go kon woship and pray to Yu for dis temple.
1KI 8:43 My Oga God, make Yu listin to dia prayer. For heaven wey Yu dey, make Yu hear and do wetin dem sey make Yu do, so dat evribody for di world go know and obey Yu, just as yor pipol Israel dey do. Den dem go know sey dis temple wey I build, na di place where dem go for dey woship Yu.
1KI 8:44 Wen Yu kommand yor pipol make dem fight war with dia enemies, if dem pray to Yu from anywhere and dem face dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu,
1KI 8:45 make Yu listin to dia prayer. Make Yu hear dem from heaven kon give dem viktory.
1KI 8:46 Wen yor pipol sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin) and Yu vex kon let dia enemies defeat and karry dem like prisonas go anoda land. Even if di land far well-well,
1KI 8:47 make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers.
1KI 8:48 If dem really turn from sin kon pray to Yu for dat land as dem face dis town wey Yu give awa grand-grand papa dem (dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu),
1KI 8:49 den make Yu listin to dia prayers. Make Yu hear from heaven kon sorry for dem.
1KI 8:50 Make Yu forgive dem wen dem sin against Yu kon make dia enemies dey respet dem.
1KI 8:51 Dem bi yor pipol wey Yu karry komot Egypt; place wey bi like sey na fire dey burn dem.
1KI 8:52 Oga God, make Yu always dey favor Israel yor pipol and dia king, den hear dia prayer wen ever dem koll Yu for help.
1KI 8:53 From all di pipol, Yu choose Israel pipol to bi yor own, bikos na so Yu tell dem thru Moses yor savant, wen Yu bring dem kom out from Egypt.”
1KI 8:54 Afta Solomon don pray to God finish, e stand for di altar front where e knee down and raiz en hand since.
1KI 8:55 Wen e stand up, e bless or di pipol as e shaut dey sey:
1KI 8:56 “Make wi praiz God wey don give en pipol peace, just as E sey E go do. E don do all di tins wey E promise Moses en savant.
1KI 8:57 Make di Oga wey bi awa God dey with us as E bin dey with awa grand-grand papa dem and make E nor leave or abandon us.
1KI 8:58 Make E make us dey obey am, so dat wi go always dey live as E wont make wi live kon keep di laws wey E give awa grand-grand papa.
1KI 8:59 Make awa Oga God remember all di prayer and komplain wey I don make with am since. Make E always dey show mesi to Israel pipol and dia king wen dem koll am evriday,
1KI 8:60 so dat all di nashons go know sey na only God bi God and e nor get anoda god.
1KI 8:61 Make una wey bi en pipol dey faithful to am and dey always obey en laws and kommand.”
1KI 8:62 Den King Solomon and all di pipol kon sakrifice give God.
1KI 8:63 Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.
1KI 8:64 Di king still dedikate di kourtyard centre with di aria for di temple front kon burn di whole sakrifice for der. E give di grain and all di fat animals as fellowship ofrins.
1KI 8:65 For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
1KI 8:66 For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.
1KI 9:1 Afta Solomon don build di temple, di palis and evritin wey e won build,
1KI 9:2 God appear to am again, just as E do for Gibeon.
1KI 9:3 God tell am, “I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always.
1KI 9:4 If yu serve mi with yor whole mind, just as David yor papa do kon obey my laws and do evritin wey I kommand yu,
1KI 9:5 I go do wetin I promise David yor papa, sey na en shidren-shidren go rule Israel forever.
1KI 9:6 But if yu and yor shidren-shidren stop to follow mi kon disobey di laws and kommand wey I give, den bigin follow oda gods,
1KI 9:7 I go remove una from Israel pipol and di land wey I give dem. I go still abandon dis temple wey I don make holy sey make dem for dey woship mi. Pipol for evriwhere go laf Israel pipol and dem nor go respet dem again.
1KI 9:8 Dis temple go skata and anybody wey waka pass, go sopraiz. Dem go sey, ‘Wetin make God do dis land and dis temple like dis?’
1KI 9:9 Pipol go ansa, ‘Na bikos dem abandon di Oga wey bi dia God wey bring dia grand-grand papa kom out from Egypt. Dem dey respet and woship oda gods, so God kon give dem dis kind big wahala.’ ”
1KI 9:10 Na twenty years Solomon take build di temple and en palis.
1KI 9:11 King Hiram for Tyre kon give Solomon all di cedar wood, pine wood and all di gold wey e wont for di work. Afta e don finish, Solomon kon give Hiram twenty towns for Galilee aria.
1KI 9:12 Wen Hiram si di towns wey Solomon gi-am, e nor like dem.
1KI 9:13 So e tell Solomon, “My broda, wetin make yu give mi dis kind towns?” So Hiram koll di towns Kabul (wey mean place wey nor good).
1KI 9:14 Before dis time, Hiram don give Solomon gold wey heavy rish 120 pounds.
1KI 9:15 Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.
1KI 9:16 Na Egypt king attack and kapture Geza before. E kill all Geza pipol kon burn di town. But wen en pikin won marry Solomon, e kon gi-am to di girl as marriage gift.
1KI 9:17 Solomon use en workers take ribuild am. Solomon still ribuild Lowa Bet-Horon;
1KI 9:18 Baalat, Tadmor for Judah desert;
1KI 9:19 di town wey dem keep en tins put; di town wey dem put en shariot and en horse dem and evry oda tin wey e won build for Jerusalem, Lebanon and oda place dem for en kingdom.
1KI 9:20 Na Kanaan shidren-shidren Solomon use take do all dis work. Dis na di pipol wey Israel pipol nor kill wen dem kom out from Egypt kon take-ova Kanaan.
1KI 9:21 Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.
1KI 9:22 Solomon nor use Israel pipol do slaves, but na sojas, ofisas, kommanders, pipol wey dey drive war horse and doz wey dey drive horse, dem bi to am.
1KI 9:23 Na 550 ofisas dey kare for doz wey dey work for difren-difren house wey Solomon dey build.
1KI 9:24 Solomon fill di land wey dey di east, afta en wife wey bi Egypt king pikin, don komot from David Town kon go stay di palis wey Solomon build for am.
1KI 9:25 Na three times a year Solomon dey give burnt and fellowship ofrin to God. E still dey burn incense give God. So e kon build di temple finish.
1KI 9:26 King Solomon still build sheep for Ezion-Geber wey dey near Elat for Akaba wotaside for Edom land.
1KI 9:27 Hiram send many of en men wey dey work for sea, go work with Solomon men.
1KI 9:28 Dem travel with ship from Ofir kon karry gold wey heavy rish 420 pounds go give King Solomon.
1KI 10:1 Wen di kween for Sheba hear about di wonderful tins wey Solomon dey do, e kon travel go Jerusalem go test am with hard-hard kweshon.
1KI 10:2 E karry plenty pipol follow body kon load spices, jewels and plenty gold full en kamels. Wen di kween si Solomon, e kon ask am all di kweshon wey dey en mind.
1KI 10:3 King Solomon ansa all di kweshon and e nor get any one wey hard am to ansa.
1KI 10:4 Sheba kween know sey King Solomon get wisdom and e si di palis wey e build;
1KI 10:5 di food wey dem serve for di tabol; di house wey en ofisas dey stay; how en workers dey do and di uniform wey dem wear; di savants wey dey serve wen dem dey do party and di sakrifice wey e dey offa for di temple. All dis tins kon sopraiz di kween well-well and fear katch am.
1KI 10:6 E tell Solomon, “Wetin I hear for my kountry about yor wisdom, na true!
1KI 10:7 But I nor bilive until naw wey I don kom si evritin by mysef. I nor even hear half of wetin I don si; bikos yor wisdom and propaty many pass as dem tell mi.
1KI 10:8 Yor ofisas and savants go dey happy well-well, bikos dem always dey with yu, dey hear di wise tins wey yu dey tok!
1KI 10:9 Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”
1KI 10:10 Sheba kween give Solomon all di gifts wey e bring and dem heavy rish 120 pounds for gold, with plenty spices and jewels. Di spices wey e give Solomon, plenty pass di ones anybody don ever gi-am before.
1KI 10:11 (Hiram pipol wey karry gold kom from Ofir, still bring plenty fine wood and jewels.)
1KI 10:12 King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.
1KI 10:13 Solomon give Sheba kween evritin wey e ask for kon still gi-am oda tins, just as dia tradishon bi, den di kween and en pipol kon go back to Sheba.
1KI 10:14 Evry year, dem dey give Solomon gold wey heavy rish 666 pounds.
1KI 10:15 Dis one nor dey join di tax wey tradas, Arab kings and di govnors for Israel dey pay gi-am.
1KI 10:16 Solomon use gold wey rish fifteen pounds take make two hundred shield.
1KI 10:17 E still use gold wey almost rish four pounds take make three hundred shield kon put all of dem for di hall wey dey Lebanon forest.
1KI 10:18 E still make one big throne. Dem kover one side for di throne with ivory kon kover di oda side with fine gold.
1KI 10:19 Na six steps dey to klimb go di throne and for di end for evry step, dem mold lion put, so all di lion kon bi twelf.
1KI 10:20 Dem mold melu head for di throne back and near di two chair hand. Dem still mold anoda lion put for di throne. E nor get any throne wey bi like dis for any oda kingdom.
1KI 10:21 Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.
1KI 10:22 Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
1KI 10:23 Solomon get propaty and e wise pass any oda king.
1KI 10:24 Evribody for di world dey won kom hear di wise tins wey God give Solomon to tok.
1KI 10:25 Evribody wey dey kom, dey bring gold, silva, robes, weapons, spices, horse and mule. And dem dey bring dem kom evry year.
1KI 10:26 Solomon gada many horse and shariot. E get 14,000 shariot and 12,000 ordinary horse. E keep dem for difren towns for Jerusalem.
1KI 10:27 Wen Solomon dey rule, silva dey evriwhere like ordinary stone for Jerusalem and cedar tree dey kommon like ordinary trees for Jerusalem.
1KI 10:28 Solomon buy en horse from Egypt and Silisia; doz wey dey sell for di king, na dem buy dem kom from Silisia for di normal prize.
1KI 10:29 Dem dey buy one shariot from Egypt for 600 silva and ordinary horse for 150 silva. Den dem go re-sell am give Hit and Siria kings.
1KI 11:1 Solomon kon love many wimen wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty wimen from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries.
1KI 11:2 E marry dem, even doh God don kommand Israel pipol make dem nor marry from doz kountries, bikos dem go make Israel pipol woship oda gods.
1KI 11:3 Solomon marry 700 wife kon get 300 girl-friends and na dem make am turn en heart from God.
1KI 11:4 Wen Solomon don old, e kon stop to follow God, unlike David en papa wey follow God until e die.
1KI 11:5 E bigin woship Astarte wey bi Sidon pipol juju and Milkom, di yeye god wey Ammon pipol dey serve.
1KI 11:6 E sin and e nor woship God, just as en papa David woship am.
1KI 11:7 For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.
1KI 11:8 E still build where en oda wifes go for dey burn incense and offa sakrifice to dia gods.
1KI 11:9 Even doh di Oga wey bi God for Israel don appear to Solomon two times sey, “Make e stop to dey woship oda gods,”
1KI 11:10 Solomon nor obey God, instead, e turn from am. So, God bigin vex for Solomon
1KI 11:11 kon tell am, “Bikos yu know wetin yu dey do as yu dey break yor kovenant with mi and nor kon dey obey my kommand, I go take di kingdom from yu kon gi-am to one of yor ofisas.
1KI 11:12 But, bikos of David yor papa, I nor go do am wen yu still dey life, but e go happen wen yor pikin go dey rule.
1KI 11:13 But I nor go take di whole kingdom from am. Instead, I go leave one tribe for am bikos of David, my savant and bikos of Jerusalem, di town wey I dey stay.”
1KI 11:14 So God kon make Hadad wey dey di royal family for Edom, turn against Solomon.
1KI 11:15 Before dis tin happen; for di time wen David win Edom pipol, Joab wey bi en sojas kommander bin go beri dead body.
1KI 11:16 En and en men stay for Edom for six monts kon kill all di men wey dey Edom,
1KI 11:17 but na only Hadad with some of en papa savant wey bi Edom pipol, naim dem nor kill, bikos dem run go Egypt and dat time, Hadad still bi small pikin.
1KI 11:18 Hadad and di men wey karry am run kon from Midian go Paran, where oda men for join dem. Den, dem travel go Egypt and Egypt king kon give Hadad some land, house and food.
1KI 11:19 Hadad kon bi di king friend, so di king gi-am en wife sista, make e marry. (Di king wife name na Tahpanhes.)
1KI 11:20 Hadad wife born boy, so e name am, “Genubat”, but na di kween kare for am for di palis and e stay with di king shidren.
1KI 11:21 Wen Hadad hear for Egypt sey King David and Joab en soja kommander don die, Hadad kon tell di king, “Make I kon dey go back to my own kountry.”
1KI 11:22 Di king ask am, “Why yu won go? E get anytin wey yu wont, wey I nor give yu? Wetin make yu won go yor kountry back?” Hadad ansa, “Abeg, my king, make I just go,” So e kon go back to en kountry.
1KI 11:23 God still make Rezon wey bi Eliada pikin, turn against Solomon. Rezon run from en oga, King Hadadeza for Zobah
1KI 11:24 kon bi leader to some pipol wey nor dey respet di law. (Dis tin happen afta David don win King Hadadeza kon kill all di sojas for Siria.) Rezon and en men go stay for Damaskus where en men for make am Siria king.
1KI 11:25 Na Israel enemy e bi thru-out di time wey Solomon bi king.
1KI 11:26 Anoda man wey turn against King Solomon na Nebat pikin, Jeroboam, wey kom from Zaretan for Efraim tribe. En mama name na Zeruah, but en papa don die.
1KI 11:27 Dis na why e turn against King Solomon. King Solomon dey work for di land for di east side for Jerusalem and e dey ripair di town walls.
1KI 11:28 Jeroboam na very strong yong man, so wen King Solomon si as e dey work well-well, e kon sey make e look ova di pipol wey dey work for Manasseh and Efraim tribe aria.
1KI 11:29 One day wen Jeroboam dey travel from Jerusalem, Profet Ahijah for Shiloh kon meet only en for road, so
1KI 11:30 di profet remove di robe wey e wear, tear am into twelf pieces
1KI 11:31 kon tell Jeroboam, “Make yu take ten pieces for yorsef, bikos di Oga wey bi Israel pipol God, sey make I tell yu, ‘I go take di kingdom from Solomon kon give yu ten tribes.
1KI 11:32 Solomon go keep one, bikos of David my savant and Jerusalem, di town wey I choose as my own from all Israel land.
1KI 11:33 I go do dis tin, bikos Solomon rijet mi kon bigin woship oda gods. E dey woship Astarte wey bi Sidon juju; Kemosh wey bi Moab pipol god and Milkom, wey Ammon pipol dey serve. Solomon nor obey mi; e dey do bad tins and e nor keep my laws and kommand, just as David en papa keep am.
1KI 11:34 “ ‘But I nor go take all di kingdom from Solomon. I go make am rule till e die. Dis na wetin I go do, bikos of David my savant, wey I choose and e obey my laws and kommand.
1KI 11:35 I go take di kingdom from Solomon pikin kon give yu ten tribes,
1KI 11:36 but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.
1KI 11:37 Jeroboam; I go make yu king for Israel and yu go rule all di aria wey yu wont.
1KI 11:38 If yu obey and follow my laws and yu win my heart as yu dey obey my kommand, just as David my savant do, I go always dey with yu. I go make yu king for Israel and I go make sure sey yor shidren-shidren go rule afta yu, just as I do for David.
1KI 11:39 Bikos Solomon sin, I go ponish David shidren-shidren, but I nor go ponish dem forever.’ ”
1KI 11:40 So, Solomon kon try to kill Jeroboam, but Jeroboam run go meet King Shishak for Egypt kon stay der till Solomon die.
1KI 11:41 Evry oda tin wey Solomon do; en works and wisdom, dem rite dem for Solomon history book.
1KI 11:42 E rule Israel land from Jerusalem for forty years.
1KI 11:43 Solomon die and dem beri am for David Town and en pikin, Rehoboam kon take-ova as king.
1KI 12:1 Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.
1KI 12:2 Wen Nebat pikin, Jeroboam hear di news, e still dey stay Egypt, di place wey e run go hide bikos of Solomon.
1KI 12:3 Dem kon send pipol go koll Jeroboam kom and all of dem go meet Rehoboam kon tell am,
1KI 12:4 “Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon remove dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”
1KI 12:5 Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.
1KI 12:6 King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”
1KI 12:7 Dem ansa am, “If yu wont make dis pipol serve yu well; give dem ansa wey dem go like and dem go use all dia heart take serve yu forever.”
1KI 12:8 King Rehoboam nor listin to dem, so e go ask di yong men wey bi en mate,
1KI 12:9 “Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”
1KI 12:10 Dem ansa, “Yu go tell dem, ‘I wiked and hard pass my papa, Solomon!’
1KI 12:11 Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard pass as e bi before. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
1KI 12:12 Afta three days, Jeroboam and di pipol go meet King Rehoboam, just as e tell dem.
1KI 12:13 Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just
1KI 12:14 as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work, hard pass as e bi before. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”
1KI 12:15 Na so God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
1KI 12:16 Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol kon bigin kworel among demsef
1KI 12:17 as dem dey waka leave Rehoboam make e bi king to only doz wey dey Judah aria.
1KI 12:18 So King Rehoboam send Adoniram wey bi di workers oga sey, make e go meet Israel pipol, but dem stone am die and as King Rehoboam hear wetin happen, e kwik-kwik enter en shariot kon run go Jerusalem.
1KI 12:19 And na since den Israel pipol for nort, bigin fight against David kingdom.
1KI 12:20 Wen all Israel Pipol hear sey Jeroboam don kom back from Egypt, dem invite am kon make am king for Israel. So, na only Judah tribe kon dey obey David shidren-shidren.
1KI 12:21 Wen Rehoboam rish Jerusalem, e koll 180,000 strong sojas from Judah and Benjamin tribe sey make dem go fight Israel tribe for nort.
1KI 12:22 But God tell Profet Shemaya,
1KI 12:23 “Make yu go tell Rehoboam, Judah and Benjamin pipol sey:
1KI 12:24 ‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house.
1KI 12:25 King Jeroboam for Israel, guide and build wall round Shekem town, wey dey di hill kountry for Efraim kon stay der for sometaim. Den e komot for der kon go build and guide Penuel town.
1KI 12:26 E tell ensef, “As tins bi naw, if my pipol go Jerusalem go give God sakrifice for di temple wey dey der,
1KI 12:27 dem go bigin respet Rehoboam for Judah, den dem go won kon kill mi.”
1KI 12:28 Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”
1KI 12:29 E put one of di gold melu for Bethel and di oda one, for Dan.
1KI 12:30 So di pipol kon sin as dem dey woship di melu wey dey Bethel and Dan.
1KI 12:31 King Jeroboam still build one place on-top di hill sey make pipol dey kom woship for der and e choose priest from family wey nor kom from Levi tribe.
1KI 12:32 King Jeroboam still dey do one feast for di fifteent day for evry eight mont, just like di feast for Judah. E make sakrifice for di gold melu on-top di altar wey e make for Bethel kon put priest for di woship place wey e build.
1KI 12:33 And for evry fifteent day for di eight mont; di day wey en ensef choose; e dey go di altar for Bethel go do sakrifice to celebrate di feast, wey e dey do for Israel pipol.
1KI 13:1 God tell one profet from Judah make e go Bethel and e rish der wen King Jeroboam stand for di altar dey do sakrifice.
1KI 13:2 Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.”
1KI 13:3 Di profet still sey, “Dis altar and di ashes wey dey inside, go skata. Den, yu go know sey God don tok thru mi.”
1KI 13:4 Wen King Jeroboam hear dis tin, e point kon sey, “Make una hold dat man!” At wons, di king hand paralaiz and e nor fit strait am again.
1KI 13:5 Di altar fall and di ashes kon skata, just as di profet tok with God name.
1KI 13:6 King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.
1KI 13:7 Den di king tell di profet, “Make yu kom chop for my house and I go give yu sometin.”
1KI 13:8 Di profet ansa, “Even if yu give mi half of evritin wey yu get, I nor go chop or drink anytin with yu.
1KI 13:9 God kommand mi sey, make I nor chop or drink anytin and make I nor go back di wey I take kom here.”
1KI 13:10 So, di profet nor follow di road wey e take kom, go back.
1KI 13:11 Dat time, e get one old profet for Bethel. E shidren kom tell am wetin di profet wey kom from Judah do for Bethel and di tins wey e tell King Jeroboam.
1KI 13:12 Di old profet ask dem, “Wish road e pass wen e dey go?” En shidren show am di road,
1KI 13:13 so e tell dem make dem ready en donkey. Afta dem ready am, di old profet enter kon
1KI 13:14 follow and meet di profet wey kom from Judah under one oak tree where e sidan. Den e ask am, “Na yu bi di profet wey kom from Judah?” Di profet ansa, “Yes! Na mi.”
1KI 13:15 So di old profet tell am, “Make yu kom my house kon follow mi chop.”
1KI 13:16 But di profet from Judah ansa, “I nor go fit follow yu go house or chop and drink anytin with yu,
1KI 13:17 bikos God don kommand mi sey make I nor chop or drink anytin for here or go back as I take kom.”
1KI 13:18 Den di old profet lie gi-am kon sey, “Mi too na profet like yu and God kommand mi thru en angel sey make I kare for yu for my house.”
1KI 13:19 So di profet wey kom from Judah follow di old profet go en house go chop.
1KI 13:20 As dem sidan for di tabol, God tok thru di old profet
1KI 13:21 and e shaut tell di profet wey kom from Judah, “God sey yu don disobey am, bikos yu nor do wetin E kommand,
1KI 13:22 but instead, yu kon go back go chop for where E sey make yu nor for chop. Bikos of wetin yu don do so, yu go die and dem nor go beri yu for yor family grave.”
1KI 13:23 Afta dem don chop finish, di old profet kon bring di Judah profet donkey kom.
1KI 13:24 And as di profet dey go for road, one lion kom out kon kill-am, den di lion and donkey kon stand near en dead body.
1KI 13:25 As some pipol dey pass, dem si di dead body for road with di lion wey stand near am. Den dem go Bethel go tok wetin dem si.
1KI 13:26 Wen di old profet hear wetin happen, e kon sey, “Dat na di profet wey nor obey wetin God kommand! So God send di lion go kill-am, just as E sey E go do.”
1KI 13:27 Den e tell en shidren, “Make una bring my donkey for mi,” Di shidren bring am and
1KI 13:28 e kon go si di profet dead body for road and di donkey and di lion still stand near am. Di lion nor chop di body or attack di donkey.
1KI 13:29 So di old profet karry di body put for di donkey kon go mourn and beri am for Bethel.
1KI 13:30 E beri am for en own family grave, den en and en shidren mourn for am and e kon sey, “Um, my broda, my broda!”
1KI 13:31 Afta dem beri am, di profet tell en shidren, “Wen I die, make una beri mi for dis grave where I beri dis profet put, den make una put my bones near en own.
1KI 13:32 Bikos all di tins wey God kommand, wey e tok against di altar for Bethel and di place wey dem for dey woship for Samaria town, must happen.”
1KI 13:33 King Jeroboam for Israel nor still shange from di bad tins wey e dey do, but e kontinue to dey choose priest from ordinary family make dem kon serve for di altar wey e build. Na pipol wey just like to bi priest, e dey make priest.
1KI 13:34 Dis sin wey e kommit kon make en kingdom skata rish groun.
1KI 14:1 Dat time, Jeroboam pikin, Abijah dey sick.
1KI 14:2 So Jeroboam tell en wife, “Shange yorsef make pipol nor know who yu bi kon go Shiloh go meet Profet Ahijah wey sey I go bi king for Israel.
1KI 14:3 Yu go gi-am ten bread; some kakes and honey. Den ask am wetin go happen to awa pikin and e go tell yu.”
1KI 14:4 So di woman go Profet Ahijah house for Shiloh. Profet Ahijah nor dey si again, bikos e don old well-well.
1KI 14:5 God don tell am sey Jeroboam wife dey kom ask am about en pikin wey nor well. So God tell Profet Ahijah wetin e go do wen Jeroboam wife kom, even doh di woman dress like anoda pesin.
1KI 14:6 As Profet Ahijah hear am dey knock di door, e ansa, “Make yu kom inside, bikos I know sey yu bi Jeroboam wife. So wetin make yu dress like anoda pesin? I get bad news for yu.
1KI 14:7 Make yu go tell King Jeroboam, ‘Dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok, “I choose yu among evribody kon make yu king for Israel.
1KI 14:8 I take di kingdom from David shidren-shidren kon give yu. But yu nor bi like David my savant wey always dey obey and do only wetin I like.
1KI 14:9 Yu don sin pass doz wey rule before yu. Yu don rijet and make mi vex, bikos yu make juju and image kon dey serve dem.
1KI 14:10 “ ‘ “Bikos of dis, I go skata yor throne kon kill all yor sons and shidren-shidren; both di ones wey don old and di yong ones. I go finish yor family; dem go swip dem komot like dirty.
1KI 14:11 Anybody for yor family wey die for inside town, na dogs go chop en dead body and vulture go chop di ones wey die for di open kountry. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”
1KI 14:12 So Profet Ahijah tell Jeroboam wife, “Naw, make yu dey go house back and as yu just dey enter di town, yor pikin go die.
1KI 14:13 All di pipol for Israel go mourn and beri am. Na only en dem go beri well for Jeroboam family, bikos na only en di Oga wey bi Israel pipol God, dey happy with.
1KI 14:14 “God go put king for Israel wey go end Jeroboam throne.
1KI 14:15 God go shake Israel land like wood wey dey float for wota. E go rut Israel pipol komot from dis good land wey E give dia grand-grand papa kon skata dem pass Eufrates River, bikos dem don make am vex as dem make Asherah juju kon dey woship am.
1KI 14:16 God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”
1KI 14:17 So King Jeroboam wife kon go back to Tirzah. As e just dey enter en house, en pikin kon die.
1KI 14:18 Israel pipol mourn and beri am, just as God tok thru en savant, Profet Ahijah.
1KI 14:19 Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.
1KI 14:20 Jeroboam rule for twenty-two years. E die and dem beri am. So, Nadab, en pikin kon take-ova as king.
1KI 14:21 Rehoboam wey bi Solomon pikin, na forty-one years e bi wen e start to rule Judah and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God don choose from all Israel aria, as di place where dem go for dey woship am. King Rehoboam mama name na Naamah wey kom from Ammon.
1KI 14:22 Judah pipol sin well-well and dem kon make God vex pass as E vex for dia grand-grand papa.
1KI 14:23 Dem build where dem for dey woship yeye gods kon use stones build Asherah juju for evriwhere, on-top di hills and for under evry green trees.
1KI 14:24 Di one wey bad pass bi sey, e get some wimen wey dey do ashawo work for doz place wey dem for dey serve juju. Judah pipol do tins wey dey make pesin shame, just as di pipol wey God drive komot for di land before, dey do.
1KI 14:25 For di fift year wen Rehoboam dey rule, King Shishak for Egypt kon attack Jerusalem.
1KI 14:26 All di good tins wey dey di temple and di gold shield wey Solomon make, di king karry dem go Egypt.
1KI 14:27 King Rehoboam make gold shield take replace dem kon put ofisas to guide di palis gate.
1KI 14:28 Anytime di king go di temple, di guards go karry di shield kom, den take am go back to di guard-room.
1KI 14:29 Evry oda tin wey Rehoboam do, dem rite dem put for Judah king history book.
1KI 14:30 Wen King Rehoboam and King Jeroboam dey rule, na so-so fight dem dey fight demsef.
1KI 14:31 Wen Rehoboam die, dem beri am for David royal grave for en town. En mama, na Naamah wey kom from Ammon and Rehoboam pikin, Abijah kon take-ova as king.
1KI 15:1 For eighteen years afta Jeroboam don bi king for Israel, Abijah kon bi Judah king
1KI 15:2 and e rule Jerusalem for three years. En mama na Maaka wey Absalom born.
1KI 15:3 E kommit sin like en papa and e nor gri respet di Oga wey bi God, just as David en grand-grand papa respet am.
1KI 15:4 But bikos of David, Oga God kon give Abijah one son wey go rule Jerusalem afta am.
1KI 15:5 God do like dis, bikos David do wetin E like and e nor disobey any of en kommand, apart from Uriaya from Hit wey e kill.
1KI 15:6 All di time wen Abijah bi king, na so-so war e dey fight with Jeroboam.
1KI 15:7 Evry oda tin wey Abijah do, dem rite am put for Judah kings history book.
1KI 15:8 Wen Abijah die, dem beri am for David Town and en pikin Asa kon take-ova as king.
1KI 15:9 For twenty years afta Jeroboam don bi king for Israel, Asa kon bi king for Judah
1KI 15:10 and e rule Jerusalem for forty-one years. En mama too na Maaka wey Absalom born.
1KI 15:11 Asa obey God, just as en grand-grand papa David do.
1KI 15:12 E drive all di men and wimen wey dey do ashawo work for where dem for dey woship juju kon skata di juju wey di former kings make.
1KI 15:13 E remove en mama Maaka, as kween moda, bikos e dey serve Asherah juju. King Asa skata di juju kon burn am for Kidron Valley.
1KI 15:14 Even doh King Asa nor skata evriwhere where dem for dey serve juju, e still dey faithful to God till e die.
1KI 15:15 All di tins wey en papa dedikate give God; di silva and gold wey en ensef dedikate, e put dem for di temple.
1KI 15:16 All di time wey King Asa for Judah and King Baasha for Israel dey rule, na so-so fight dem dey fight demsef.
1KI 15:17 King Baasha skata Judah kon put sojas for Rama, so dat nobody go fit enter or go out from Judah.
1KI 15:18 So, King Asa karry all di silva and gold wey remain for di temple and di palis kon give dem to some of en ofisas with dis message, go Damaskus go give King Ben-Hadad for Siria. Na Tabrimmon bi Ben-Hadad papa and na Hezion born Tabrimmon.
1KI 15:19 Di message wey e send go na: “Make wi bi friends, just as awa papa dem bi. Dis silva and gold na di gift wey I give yu. Make yu nor bi friend with King Baasha for Israel again, so dat e go remove en sojas from my aria.”
1KI 15:20 King Ben-Hadad agri with wetin King Asa tok and e send en soja kommander make dem go attack Israel town. Dem attack and katch Ijon, Dan, Abel-Bet Maaka; di arias near Galilee wotaside and evriwhere for Naftali.
1KI 15:21 Wen King Baasha hear wetin happen, e pak en sojas from Rama kon go Tirzah.
1KI 15:22 Den King Asa send message go evriwhere for Judah sey make evribody help am karry di stones and timbas wey King Baasha take fence Rama komot. Asa kon use di tins take fence Mizpa and Gibeah wey bi towns for Benjamin aria.
1KI 15:23 Dem rite evry oda big tin wey King Asa do, plus di towns wey e fence, for Judah kings history book. But wen e don old, e kon get diziz for en leg.
1KI 15:24 King Asa die and dem beri am for di royal grave for David Town and Jehoshafat, en pikin kon take-ova as king.
1KI 15:25 For di sekond year wen King Asa don dey rule Judah, Nadab wey bi Jeroboam pikin kon bi king for Israel and e rule for two years.
1KI 15:26 E sin against God, just as en papa Jeroboam do.
1KI 15:27 Baasha wey bi Ahijah pikin, wey kom from Issakar tribe kon plan against Nadab and e kill-am wen en and en sojas won take-ova Gibbeton for Filistia.
1KI 15:28 Dis tin happen for di third year wen Asa bi king for Judah. So Baasha take-ova from Nadab as Israel king.
1KI 15:29 At wons, e bigin kill all Jeroboam family. So dat wetin God tok thru Profet Ahijah from Shiloh, go happen. Dem kill evribody for Jeroboam family and no one remain.
1KI 15:30 Dis tin happen, bikos Jeroboam make di Oga wey bi Israel God vex, with di sins wey en and Israel pipol kommit.
1KI 15:31 Evry oda tin wey Nadab do, dem rite am for Israel kings history book.
1KI 15:32 Thru-out di time wen King Asa for Judah and King Baasha for Israel dey rule, na so-so fight dem dey fight.
1KI 15:33 For di third year wen Asa don bi king for Judah, Baasha wey Ahijah born kon bi king for Israel and e rule from Tirzah for twenty-four years.
1KI 15:34 E nor obey God at-all and e make Israel pipol sin, just as Jeroboam do.
1KI 16:1 God send Profet Jehu, Hanani pikin, go meet and give Baasha dis message:
1KI 16:2 “Even doh yu nor important, I still make yu lead my pipol, Israel. Naw yu don disobey mi like Jeroboam kon make my pipol sin and dia sins don make mi dey vex.
1KI 16:3 So, I go kill yu and yor family as I do Jeroboam.
1KI 16:4 Anybody for yor family wey die for town, na dog go chop am and any one wey die for open field, na vulture go chop am.”
1KI 16:5 Evry oda tin wey Baasha do, dem rite am for Israel kings history book.
1KI 16:6 King Baasha die and dem beri am for Tirzah. En pikin, Elah kon take-ova as king.
1KI 16:7 Na God give Profet Jehu di message wey e tok against King Baasha and en family, bikos of di sin wey dem kommit. Nor bi only en wikedness dey make God vex, but na bikos e kill evribody for Jeroboam family.
1KI 16:8 For di twenty-sixt year wen Asa don bi king for Judah, Elah wey bi Baasha pikin kon bi king for Israel and e rule from Tirzah for two years.
1KI 16:9 Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der.
1KI 16:10 Zimri enter di house kon kill and take-ova from King Elah. Dis tin happen for di twenty-sevent year wey Asa bi king for Judah.
1KI 16:11 As Zimri just bikom king, e kon kill evribody for Baasha family. E kill all di men wey rilate to Baasha kon still kill en friends.
1KI 16:12 So wetin God tok against Baasha thru Profet Jehu kon happen, bikos Zimri don kill evribody for Baasha family.
1KI 16:13 Bikos dem dey woship juju and dem make Israel pipol sin, King Baasha and en pikin Elah kon make di Oga wey bi Israel pipol God, vex well-well.
1KI 16:14 Evry oda tin wey Elah do, dem rite am for Israel kings history book.
1KI 16:15 For di twenty-sevent year wey Asa don bi king for Judah, Zimri kon rule Israel pipol from Tirzah for seven days, wen Israel sojas dey take-ova Gibbeton town for Filistia
1KI 16:16 and wen dem hear sey Zimri plan kill di king, for where all of dem dey, dem kon make Omri wey bi dia kommander, king for Israel.
1KI 16:17 Omri with en sojas komot from Gibbeton go take-ova Tirzah.
1KI 16:18 Wen Zimri si sey dem don take di town, e enter inside di palis inna room, lite fire for der kon die inside.
1KI 16:19 Dis tins happen, bikos e sin against God. E do bad tins like Jeroboam wey sin and enkourage Israel pipol to sin.
1KI 16:20 Evry oda tin wey Zimri do and how e plan against pipol, dem rite dem for Israel kings history book.
1KI 16:21 Israel pipol kon divide, some of dem wont make Tibni wey bi Ginat pikin, bi dia king and di odas dey for Omri side.
1KI 16:22 At last doz wey dey Omri side kon win, bikos Tibni die and Omri kon bi king.
1KI 16:23 So for di thirty-first year wey Asa don dey rule Judah, Omri kon bi king for Israel and e rule for twelf years. Na from Tirzah e for rule for di first six years
1KI 16:24 and e buy Samaria hill with 6,000 silva from one man wey dem dey koll Shema, wey bin get di hill.
1KI 16:25 King Omri sin worse pass di sin wey doz wey don rule before am, do.
1KI 16:26 Like Jeroboam wey don rule before am, e make di Oga wey bi Israel God vex, bikos e sin and enkourage Israel pipol to serve juju.
1KI 16:27 Evry oda tin wey Omri do, dem rite am for Israel kings history book.
1KI 16:28 King Omri die and dem beri am for Samaria and en pikin, Ahab kon take-ova as king.
1KI 16:29 For di thirty-eight year wey Asa don bi king for Judah, Ahab wey bi Omri pikin kon bi king for Israel and e rule from Samaria for twenty-two years.
1KI 16:30 En own sin against God, worse pass all di pipol wey don rule before am.
1KI 16:31 E nor only kommit sin like Jeroboam, but e go marry Jezebel wey bi King Etbaal for Sidon, pikin and Ahab still dey woship Baal.
1KI 16:32 For Samaria, e build temple, make altar kon put Baal for inside.
1KI 16:33 E still build Asherah juju. Di tins wey e do, make God vex pass wetin all di oda kings for Israel don do before.
1KI 16:34 For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.
1KI 17:1 E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”
1KI 17:2 Den God tell Elijah,
1KI 17:3 “Make yu komot der go hide near Kerit Valley for Jordan River east.
1KI 17:4 Di valley go bring out wota wey yu go drink and I don kommand birds make dem bring food kom give yu for der.”
1KI 17:5 Elijah obey God kommand kon go stay for Kerit Valley.
1KI 17:6 E dey drink wota from di valley and birds dey bring bread and meat kon gi-am evry morning and evening.
1KI 17:7 Afta sometaim, di valley kon dry, bikos rain nor fall again.
1KI 17:8 Den God tell Elijah,
1KI 17:9 “Naw make yu go Zarefat town wey dey near Sidon. I don tell one woman wey e husband don die make e give yu food.”
1KI 17:10 So Elijah go Zarefat and as e rish di gate, e si one woman wey e husband don die dey gada firewood. So Elijah tell am, “Abeg! Make yu give mi wota make I drink.”
1KI 17:11 As di woman dey go bring am, e still tell am, “Make yu still bring bread kom for mi too.”
1KI 17:12 Di woman ansa, “I promise with God wey dey alive sey, I nor get bread. Di only tin wey I get na small flower for plate and olive oil for cup. I kom gada firewood make I use take make am for mi and my pikin. Na dat one bi di last food wey wi go chop before honga go kill us.”
1KI 17:13 Elijah tell am, “Make yu nor worry. Just go kook yor food, but first make one bread from wetin yu get kon give mi, den go make di remainin ones for yu and yor pikin.
1KI 17:14 Bikos di Oga wey bi Israel God sey: ‘Flower and oil nor go finish from yor plate and cup till di day wey God go make rain fall.’ ”
1KI 17:15 Di woman kon go do wetin Elijah tell am and all of dem si food chop for many days.
1KI 17:16 As God don promise thru Elijah, flower and oil nor finish from di woman plate and cup.
1KI 17:17 Afta sometaim, di woman pikin kon bigin sick. Bikos di sickness strong well-well, di pikin kon die.
1KI 17:18 Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”
1KI 17:19 Elijah tell am, “Make yu give mi di pikin.” Elijah karry di pikin from am, klimb go di room wey e dey stay for up kon put am for bed.
1KI 17:20 Den e shaut kon pray, “My Oga God, why Yu allow dis kind bad tin happen to dis woman? E dey kind and dey kare for mi! Naw, Yu don allow en pikin die.”
1KI 17:21 Den Elijah liedan on-top di pikin three times dey pray kon sey, “My Oga God, make Yu give dis pikin life again!”
1KI 17:22 God ansa Elijah prayer, so di pikin kon kough and start to breath again.
1KI 17:23 Elijah karry di pikin go down kon tell en mama, “Si, yor pikin don kom back to life!”
1KI 17:24 Di woman ansa, “Na naw I know sey yu bi God savant and God dey really tok thru yu!”
1KI 18:1 Afta sometaim, for di third year wey rain nor gri fall, God tell Elijah, “Make yu go meet King Ahab and I go make rain fall.”
1KI 18:2 So Elijah go meet King Ahab. Dat time, e nor dey eazy to plant food for Samaria.
1KI 18:3 So Ahab koll Obadaya wey dey kare for di palis. Obadaya dey serve God with all en mind.
1KI 18:4 Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.
1KI 18:5 King Ahab tell Obadaya, “Make yu go all di land; pass thru di wota and di valley kon shek weda yu go si any aria wey grass dey, so dat di animals go-go chop for der, make dem nor for die.”
1KI 18:6 Ahab and Obadaya kon divide di land among demsef. One go dis side, while di oda one go di oda side.
1KI 18:7 As Obadaya dey go en side, Elijah kon si am. As Obadaya notis sey na Profet Elijah, e fall face groun kon sey, “My oga, Elijah! Na yu really bi dis?”
1KI 18:8 Elijah ansa, “Yes! Na mi. Make yu go tell yor oga sey, ‘Elijah don kom back.’ ”
1KI 18:9 Obadaya kon sey, “Wetin I do wey make yu wont make King Ahab kill mi yor savant?
1KI 18:10 As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.
1KI 18:11 Naw, yu dey sey, ‘Go tell yor oga sey, “Elijah don kom back.” ’
1KI 18:12 But wen I leave yu, God Spirit go karry yu komot sotey I nor go si yu again. If I go tell King Ahab sey I don si yu, den e find and nor si yu, e go just sey make dem kill mi. Dat one nor good, bikos yor savant dey serve God well-well, since wen e bi small pikin.
1KI 18:13 And na true sey, my oga know wetin I do wen Jezebel dey kill God profets. I hide hundred profets for two kave, fifty-fifty for each kave and I dey give dem wota and food.
1KI 18:14 Naw yu sey, ‘Go tell yor oga, “Elijah don kom back.” ’ But e go kill mi.”
1KI 18:15 Elijah kon sey, “As long as God wey get pawa wey I dey serve dey alive, I go let King Ahab si mi today.”
1KI 18:16 Wen Obadaya go tell King Ahab wetin Elijah tok, di king kon go meet am.
1KI 18:17 Wen Ahab si Elijah, e tell am, “Na yu really bring dis wahala kom Israel?”
1KI 18:18 Elijah ansa, “I nor bring wahala kom Israel. But na yu and yor papa family bring wahala as una abandon God kommand kon follow Baal.
1KI 18:19 Naw, send message go gada Israel pipol kom meet mi for Mount Karmel with Baal 450 profets and Asherah juju 400 profets wey Jezebel dey support.”
1KI 18:20 King Ahab send message go meet Israel pipol and dem gada all di profets for Mount Karmel.
1KI 18:21 Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.
1KI 18:22 Elijah kon tell dem, “Na only mi bi God profet wey remain, but Baal profet na 450.
1KI 18:23 Make dem bring two melu kom give us. Dem go choose one for diasef, kut am into pieces kon put am for di wood. But dem nor go put fire. I go do di same tin to di oda melu and I nor go put fire too.
1KI 18:24 Una go koll una god name and I go koll my God name. Den, di one wey go ansa with fire, na-im bi di true God.” All di pipol ansa, “Dis test na good one.”
1KI 18:25 Elijah tell Baal profets, “Make una first choose one among di melu kon start, bikos na una plenty pass. Make una koll una god name, but make una nor lite fire put.”
1KI 18:26 So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange. Dem koll dia juju, Baal name from morning go rish aftanoon kon dey sey, “Baal! Make yu ansa us o-o.” But e nor ansa dem, even as dem dey jump anyhow for di altar wey dem make.
1KI 18:27 For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”
1KI 18:28 So dem shaut well-well, just as dem always dey do for dia juju. Dem use spear and swod dey kut demsef, until blood bigin komot from dia body.
1KI 18:29 Dem shaut and kry till aftanoon, but dem nor hear any sound, ansa or anytin.
1KI 18:30 Elijah kon tell di pipol, “Make una kom meet mi.” So all di pipol go meet am. E ripair God altar wey don skata since.
1KI 18:31 Den Elijah karry twelf stones wey stand for Jakob twelf tribes wey God tell sey, “Na Israel go bi una new name.”
1KI 18:32 E kon use di stones make altar give God. E dig one big gutta round di altar wey go kontain four gallon of wota.
1KI 18:33 E arrange di firewood kon kut di melu put on-top. Den e sey, “Make una fetch wota put for four gallon kon pour am on-top di ofrin and wood.” So den do as e tok.
1KI 18:34 Den Elijah sey, “Make una do am again and again.” So dem do am three times.
1KI 18:35 Di wota rush kom down from di altar kon full di gutta.
1KI 18:36 Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.
1KI 18:37 My Oga God! Make Yu ansa mi! Ansa mi, so dat pipol go know sey na Yu bi di true God, den dem go turn from dia sins kom meet Yu.”
1KI 18:38 At wons, fire from God kon fall from heaven. Di fire burn di ofrin, di wood, di stones and di dirty kon dry di wota wey dey di gutta.
1KI 18:39 Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”
1KI 18:40 Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.
1KI 18:41 Den Elijah tell King Ahab sey, “Make yu go drink and chop, bikos yu go soon hear heavy rain as e dey kom.”
1KI 18:42 So King Ahab go chop and drink and Elijah klimb go Mount Karmel. E bend kon put en face for en leg centre, den e kon dey pray.
1KI 18:43 Leta e tell en savants, “Make yu go look di side wey di sea dey.” So di savant go look am kon kom back sey, “Nor-tin dey der.” Elijah kon send am go look again for seven times.
1KI 18:44 For di sevent time, di savant kon tell am, “I si one small kloud wey bi like pesin hand dey raiz from di sea.” Elijah kon sey, “Make yu go tell King Ahab sey rain dey kom. Make yu go with di shariot, so dat di rain nor go meet yu for road.”
1KI 18:45 So dark kloud kon kover di sky; di wind blow and heavy rain bigin fall. King Ahab ride dey go Jezrel.
1KI 18:46 Naw God give Elijah pawa, so e tie en rope round en waist kon run with leg pass Ahab go Jezrel.
1KI 19:1 King Ahab tell Jezebel all wetin Elijah do and how e kill all di Baal profets with en swod.
1KI 19:2 Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”
1KI 19:3 Elijah kon dey fear, so e run go Beersheba for Judah. E leave en savant for der,
1KI 19:4 as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”
1KI 19:5 E kon sleep under di tree. At wons, one angel tosh am kon sey, “Make yu stand up kon chop.”
1KI 19:6 As e look, e si bread and wota for bottol near en head. E chop di bread and drink wota, den e sleep again.
1KI 19:7 God angel wake am di sekond time sey, “Get up make yu chop, bikos di waka wey yu won waka so, hard well-well.”
1KI 19:8 Elijah get up kon chop and drink wota again, den di food gi-am pawa to take waka for forty days go di holy mountin for Sinai.
1KI 19:9 For der, e enter inside one kave kon sleep dat nite. At wons, God koll am, “Elijah, wetin yu dey do for here?”
1KI 19:10 E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
1KI 19:11 God tell am, “Make yu go stand for my front for di mountin. Si! God dey ready to waka pass.” God send one strong breeze go shake di hills and di rocks, but God nor dey inside di breeze. Afta di breeze stop, di groun kon dey shake and swallow tins, but God nor dey inside.
1KI 19:12 Afta, fire kom out, but God nor still dey inside di fire too. Afta di fire, Elijah kon hear one small vois.
1KI 19:13 As e hear am, e kover en face with en klot kon waka go di kave door-mot for outside. Den one vois tell am, “Elijah! Wetin yu dey do for here?”
1KI 19:14 E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve. But Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too.”
1KI 19:15 God tell am, “Elijah! Make yu go back to di desert wey dey near Damaskus, enter di town go anoint Hazael as Siria king.
1KI 19:16 Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu.
1KI 19:17 Anybody wey eskape and Hazael nor fit kill-am, Jehu go kill-am and anybody wey eskape from Jehu, Elisha go kill-am.
1KI 19:18 But I still get 7,000 pipol for Israel wey dey obey mi and neva serve Baal before.”
1KI 19:19 Elijah komot from der kon si Elisha, wey Shafat born, dey work with twelf melu for en farm. E sidan on-top one, while eleven dey en front. Elijah remove en own klot kon use am take kover Elisha body.
1KI 19:20 So, Elisha leave en melu dem kon follow Elijah, den e sey, “Make I go tell my papa and mama, ‘Bye-bye,’ den I go follow yu.” Den Elijah ansa, “Okay! Make yu go tell dem, but tink am well-well, before yu kom follow mi!”
1KI 19:21 Elisha go back kon kollect en own melu, kill and kook dem, den e give di meat to pipol make dem chop. So Elisha follow Elijah kon dey help am.
1KI 20:1 King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas, with thirty-two oda kings, with dia horse and shariot, den dem mash go attack Samaria.
1KI 20:2 King Ben-Hadad send messenjas go meet and tell King Ahab,
1KI 20:3 “Make yu surenda yor silva and gold; yor wimen and yor shidren wey strong well-well give mi.”
1KI 20:4 King Ahab ansa, “Make una tell my oga, King Ben-Hadad sey I gri. Make e take mi and evritin wey I get.”
1KI 20:5 Leta di messenjas kom back to King Ahab sey King Ben-Hadad still dey ask for anoda tin, “I bin sey make yu give mi all yor silva and gold, yor wimen and shidren.
1KI 20:6 But I go send my ofisas make dem take yor palis, yor ofisas house and evry betta tin wey dey inside. Na dis kind time dem go take kom tumoro.”
1KI 20:7 King Ahab koll di leaders kon tell dem, “Una si sey dis man won kollect evritin wey wi get? E sey make I gi-am my wifes, shidren, silva and gold and I gri.”
1KI 20:8 Di leaders and di pipol ansa, “Make yu nor listin to am, nor gri!”
1KI 20:9 So King Ahab tell King Ben-Hadad messenjas sey, “Make una go tell di oga my king sey I gri for di first tin wey e tok, but I nor gri for di sekond one.” Den di messenjas go kon kom back with anoda message
1KI 20:10 from Ben-Hadad sey, “I go bring men kom distroy dis yor town and dem go use dia hand karry all di good tins komot. Make di gods kill mi, if I nor do am.”
1KI 20:11 Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
1KI 20:12 Dem tell King Ben-Hadad wetin King Ahab tok for where en and en oda rulers sidan dey drink for dia tent. So e kon give en men orda sey make dem ready to attack di town, den dem divide diasef into group.
1KI 20:13 But one profet go meet Ahab kon tell am, “God sey, ‘Make yu nor fear doz many sojas! I go make yu win dem today and yu go know sey, na mi bi God.’ ”
1KI 20:14 Ahab ask, “Who go lead for di attack?” Di profet ansa, “God sey make e bi di yong sojas wey di district govnor dey kommand.” Di king kon ask, “Den who go kommand di main sojas?” Di profet ansa, “Na yu.”
1KI 20:15 So di king koll di 232 yong sojas wey dey under di district kommander. Den e koll all Israel sojas and dem bi 7,000 men.
1KI 20:16 Dem attack for aftanoon wen King Ben-Hadad and en thirty-two kings wey e karry follow body dey drink for dia tent.
1KI 20:17 Na di yong sojas kom out first. Pipol wey Ben-Hadad send go, kom tell am sey some sojas dey kom out from Samaria.
1KI 20:18 Den e give orda sey, “Make una kill dem, weda dem dey kom fight or make peace.”
1KI 20:19 Na di yong sojas first attack, den Israel sojas kon follow dem for back
1KI 20:20 and each of dem kill di man wey e dey follow fight. Siria pipol kon dey run and Israel pipol bigin porshu dem, but King Ben-Hadad and some among en men enter horse kon run.
1KI 20:21 King Ahab enter di field, karry dia horse and dia shariot kon win Siria pipol.
1KI 20:22 Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”
1KI 20:23 King Ben-Hadad ofisas kon tell am, “Na gods for mountin bi Israel pipol gods, naim make dem fit win us. But wi go win dem, if wi fight dem for ordinary groun.
1KI 20:24 Naw, make yu remove di thirty-two kings kon put doz wey sabi kommand sojas for field, yu go make dem di sojas oga.
1KI 20:25 Den koll sojas wey many like di ones wey run leave yu, with di same nomba of shariot and ordinary horse. Wi go fight Israel pipol for ordinary groun and wi go win dem dis time.” King Ben-Hadad gri kon follow dia advise.
1KI 20:26 For di next rainin sizin, e gada en men kon follow dem mash go Afek town go attack Israel pipol.
1KI 20:27 Israel pipol gada kon ready diasef; dem mash go kamp for two group kon face Siria pipol. Israel pipol bi like small-small goat, bikos Siria pipol plenty kon full evriwhere for di kountry.
1KI 20:28 One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipol tok sey I bi god for mountin and nor bi for groun, I go make yu win dia many sojas and yu and yor pipol go know sey na mi bi God.’ ”
1KI 20:29 Israel and Siria pipol face diasef for dia kamps for seven days. For di sevent day, dem kon bigin fight and Israel pipol kill 100,000 Siria men.
1KI 20:30 Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.
1KI 20:31 En ofisas go meet am sey, “Wi hear sey Israel pipol kings dey show mesi. Make wi wear sak klot go meet am; may bi e nor go kill yu.”
1KI 20:32 So, dem wear sak klot go meet King Ahab kon tell am, “King Ben-Hadad yor savant dey beg yu make yu nor kill-am.” King Ahab ansa, “E still dey alive? Okay! E bi like broda to mi!”
1KI 20:33 Ben-Hadad ofisas dey look how Ahab go tok and wen e sey, “Broda,” dem kon hold dat word sey, “Yu sey Ben-Hadad na yor broda!” So King Ahab give orda sey, “Make una bring Ben-Hadad kom.” Wen King Ben-Hadad kom, King Ahab kon tell am sey make e enter di shariot with am.
1KI 20:34 Ben-Hadad tell am, “I go give yu di towns wey my papa kollect from yor papa and yu fit make one place wey yu go for dey sell for Damaskus, just as my papa do for Samaria.” King Ahab ansa, “If na bikos of dis, I go free yu.” E make agriment with am kon let am go.
1KI 20:35 As God kommand, one profet among all di profets kon sey make dem beat am. But di oda profet nor gri,
1KI 20:36 so di first profet sey, “Bikos yu don disobey wetin God kommand, one lion go kill yu as yu just komot from here.” And as e komot, one lion kom out kon kill-am.
1KI 20:37 Den di same profet go meet anoda man sey, “Make yu beat mi!” Di man beat am well-well and e pain am.
1KI 20:38 Di profet bandage en face with klot kon shange ensef, den go stand for road korna dey wait make Israel king pass.
1KI 20:39 As di king dey pass, di profet koll am kon sey, “My king, I dey fight war and one soja bring enemy wey dem katch kon meet mi sey, ‘Make yu guide dis man. If e eskape; yu go die or yu go pay 3,000 silva koin.’
1KI 20:40 But bikos I dey do oda tins, di man kon eskape.” Di king ansa, “Yu don judge yorsef, so yu must pay di prize.”
1KI 20:41 Di profet tear di klot from en face and at wons, di king kon si sey na one of di profets.
1KI 20:42 Di profet kon tell di king, “Dis na wetin God sey make I tell yu, ‘Bikos yu let di man wey I sey make dem kill eskape, yu go use yor life pay for en own and dem go distroy yor sojas, bikos dem let en sojas eskape.’ ”
1KI 20:43 So di king go back to Samaria and di word kon dey worry am for mind.
1KI 21:1 E get one vineyard wey dey near King Ahab palis for Jezrel and na Nabot get am.
1KI 21:2 One day, Ahab tell Nabot, “Make yu give mi yor vineyard wey dey near my palis, bikos I won use di land take do vegitabol farm. I go give yu anoda vineyard or pay yu betta prize for dis one.”
1KI 21:3 Nabot ansa, “I inherit dis vineyard from my grand-grand papa. God forbid sey I go give or sell am to yu!”
1KI 21:4 King Ahab kon dey vex and e nor happy with wetin Nabot tell am. E liedan face di wall for en bed and e nor gri chop.
1KI 21:5 Jezebel en wife go ask am, “Why yu dey vex like dis? Why yu nor gri chop?”
1KI 21:6 E ansa, “Na bikos of wetin Nabot tell mi. I sey make I buy en vineyard, or if e like, make I gi-am anoda one, but e nor gri!”
1KI 21:7 Jezebel ansa, “Nor bi yu bi di king? Make yu stand up from bed go chop. I go make sure sey yu take Nabot vineyard!”
1KI 21:8 Den Jezebel rite leta, sign am with Ahab name, use en seal take seal am kon send am go give di ofisas and doz wey bi leaders for Jezrel.
1KI 21:9 Di leta sey, “Make una kwik-kwik gada di pipol make dem fast and pray den make Nabot dia leader.
1KI 21:10 Make una arrange two jaguda make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot for di town kon stone am die.”
1KI 21:11 Di ofisas and di leaders for Jezrel kon do wetin Jezebel tok.
1KI 21:12 Dem choose one day to fast kon make Nabot di leader among di pipol.
1KI 21:13 Leta, di two jaguda kon akuiz Nabot sey, e curse God and di king, so dem take am go outside di town kon stone am die.
1KI 21:14 Dem send message go give Jezebel sey, “Dem don stone Nabot die.”
1KI 21:15 As Jezebel just si di message, e tell King Ahab, “Naw, Nabot don die. So make yu go take di vineyard wey e nor gri sell give yu.”
1KI 21:16 At wons, Ahab go di vineyard kon take-ova.
1KI 21:17 Den God tell Profet Elijah wey kom from Tishbe sey,
1KI 21:18 “Make yu go meet King Ahab for Samaria. Yu go si am for Nabot vineyard wey E take by force.
1KI 21:19 Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”
1KI 21:20 Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.
1KI 21:21 So God sey, ‘I go put wahala for yor head. I go kill yu and all di men for yor family; both yong and old ones.
1KI 21:22 Yor family go bi like King Jeroboam wey Nebat born and like Baasha wey bi Ahijah pikin. Bikos yu don make mi vex, as yu make Israel pipol dey sin.’
1KI 21:23 “And for Jezebel yor wife, God sey, ‘Na dogs go chop en body for Jezrel town.’
1KI 21:24 “Anybody for yor relashon wey die for di town, na dog go chop am and any one wey die for di open field, na vulture go chop am.”
1KI 21:25 (E nor get any oda pesin wey do dis kind bad tin for God present, like Ahab, just bikos of en wife Jezebel.
1KI 21:26 Na-im kommit di sin wey big pass, wen e go woship juju like Amor pipol wey God drive komot for di land, before Israel pipol kom.)
1KI 21:27 Wen Elijah tok finish, King Ahab tear en klot kon wear sak klot. E nor gri chop; e sleep with di sak klot and e kon dey sorry for ensef.
1KI 21:28 Den God tell Profet Elijah,
1KI 21:29 “Yu don si how King Ahab honbol ensef for mi since wen yu tell am wetin I tok? I nor go bring wahala kon gi-am wen e still dey life, but na en pikin go take head karry am.”
1KI 22:1 Peace kon dey between Israel and Siria for two years,
1KI 22:2 but for di third year, King Jehoshafat for Judah go si King Ahab for Israel.
1KI 22:3 King Ahab ask en ofisas, “Since na wi get Ramot for Gilead, wetin make us neva try to kollect am back from Siria king?”
1KI 22:4 So King Ahab ask King Jehoshafat, “Yu go follow mi go attack Ramot for Gilead?” Jehoshafat ansa, “Mi and my sojas dey ready, if yu ready.
1KI 22:5 But make wi ask God first.”
1KI 22:6 So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”
1KI 22:7 But King Jehoshafat ask, “E nor get anoda profet wey wi fit still ask?”
1KI 22:8 King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
1KI 22:9 Den King Ahab koll di offisa for di kourt kon sey make e go bring Profet Mikaya kom.
1KI 22:10 Di two kings wear dia royal robes kon sidan for dia thrones for di gardin for Samaria gate and all di profets bigin profesai for dem.
1KI 22:11 One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”
1KI 22:12 All di oda profets tok di same tin kon sey, “Make yu go attack Ramot for Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
1KI 22:13 Di ofisas wey go koll Mikaya kon tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
1KI 22:14 But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”
1KI 22:15 Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
1KI 22:16 But King Ahab ansa, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”
1KI 22:17 So Mikah kon ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, so make dem go dia house with peace.’ ”
1KI 22:18 Den King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”
1KI 22:19 Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.
1KI 22:20 God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’ “Di angels kon dey tok difren tins,
1KI 22:21 until one spirit kom out kon tell God, ‘I go-go deceive am.’
1KI 22:22 “God ask am, ‘How yu wont take deceive am?’ “Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’ “So God tell am, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
1KI 22:23 Profet Mikah still sey, “Dis na wetin don happen. God don make dis profets lie to yu. But en ensef don tok sey yu go si wahala!”
1KI 22:24 Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
1KI 22:25 Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”
1KI 22:26 King Ahab kon give orda sey, “Make una arrest and karry Mikaya go Amon, di ofisas town and Joash, my pikin, dey der too.
1KI 22:27 Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”
1KI 22:28 Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una hear wetin I tok so o-o!”
1KI 22:29 Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead.
1KI 22:30 King Ahab tell King Jehoshafat, “As wi dey go di war so, I go shange my klot, but make yu wear yor royal robe.” So Israel king shange kon go di war.
1KI 22:31 Siria king don kommand en thirty-two kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king.
1KI 22:32 So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut,
1KI 22:33 den dem kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.
1KI 22:34 So one Siria soja trow en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”
1KI 22:35 As di war dey kontinue, King Ahab just dey for en shariot face Siria pipol. Di blood from en body kon kover en shariot, so e kon die for evening.
1KI 22:36 As evening dey rish, dem kon orda Israel pipol make dem dey go back to dia house.
1KI 22:37 Na so King Ahab take die and dem karry am go Samaria go beri.
1KI 22:38 Just as God sey e go happen, dem wosh di shariot for Samaria pool where ashawo for dey baf, den dogs kon dey lick Ahab blood.
1KI 22:39 Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book.
1KI 22:40 Ahab die and en pikin, Ahazaya kon take-ova as king.
1KI 22:41 For di fourt year wey Ahab bi king for Israel, Asa pikin, Jehoshafat kon bi king for Judah.
1KI 22:42 Jehoshafat na thirty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for twenty-five years. En mama na Azuba, wey bi Shilhi pikin.
1KI 22:43 E do like en papa Asa kon dey obey and do only di tins wey God wont, but e nor skata di place where dem for dey woship juju, so di pipol kontinue to burn incense and offa sakrifice to dia juju.
1KI 22:44 Jehoshafat make peace with Israel king.
1KI 22:45 Di remainin tins wey King Jehoshafat do; with all en good works and di sojas wey e get, dem rite dem for Judah kings history book.
1KI 22:46 E remove all di men and wimen ashawo wey dey woship for di juju altars; di ones wey still remain wen Asa, en papa bi king.
1KI 22:47 For dis time, Edom nor get king, na govnor dey rule dem.
1KI 22:48 King Jehoshafat build plenty big ship wey dey travel go get gold for Ofir, but dem sink for Ezion-Geber.
1KI 22:49 Den King Ahazaya wey bi Ahab pikin kon tell King Jehoshafat sey, “Make my men join yor plenty ship,” But Jehoshafat nor gri.
1KI 22:50 King Jehoshafat die and dem beri am for en grand-grand papa, David Town. Jehoram en pikin kon take-ova as king.
1KI 22:51 For di sevent year wey Jehoshafat bi king for Judah, Ahazaya wey bi Ahab pikin kon dey rule Israel from Samaria.
1KI 22:52 E nor obey God and e dey do di kind bad-bad tins wey en papa and mama do. E make Israel pipol sin, just as Jeroboam wey bi Nebat pikin, tell dem to do.
1KI 22:53 E woship Baal kon make di Oga wey bi Israel pipol God vex and na so en papa do too.
2KI 1:1 Afta Ahab don die, Moab pipol kon go fight Israel pipol.
2KI 1:2 For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”
2KI 1:3 But God angel tell Profet Elijah wey kom from Tishbe, “Get up! Go meet di messenjas wey Samaria king send kon tell dem, ‘Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God?
2KI 1:4 So make una hear wetin God dey tell di king: “Yu nor go stand up from di bed wey yu dey so, bikos yu must die!” ’ ” So Elijah kon go.
2KI 1:5 Wen di messenjas go back, di king kon ask dem, “Wetin make una kwik kom back like dis?”
2KI 1:6 Dem ansa, “One man tell us, ‘Make una go back go tell di king sey, “Dis na wetin God tok: Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God? So di king nor go stand up from di bed wey e dey so, bikos e go die.” ’ ”
2KI 1:7 Di king kon ask dem, “Make una diskribe di man wey tell una all dis tin.”
2KI 1:8 Dem ansa, “E get hair full en body kon tie leda belt for waist.” Di king kon sey, “Dat na Elijah wey kom from Tishbe.”
2KI 1:9 Den di king send one offisa with fifty sojas make dem go arrest Elijah kom. Dem go meet Elijah for where e sidan on-top hill kon tell am, “Profet! Di king sey make yu follow us kom!”
2KI 1:10 Elijah ansa di soja oga, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down, burn all of dem.
2KI 1:11 Di king send anoda offisa and fifty sojas go again. Di offisa tell Elijah sey, “Profet! Di king sey make yu follow us kom.”
2KI 1:12 Den Elijah ansa, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down kon burn all of dem.
2KI 1:13 Di king still send anoda offisa and fifty sojas go. Dis third offisa go meet Elijah kon fall for en front dey beg am, “Profet! Abeg, make yu nor kill mi and my men wey bi yor savants.
2KI 1:14 True-true, wi know sey, fire kom down from heaven kon kill di two ofisas with dia men wey first kom. So wi dey beg make yu nor kill us.”
2KI 1:15 So God angel tell Elijah, “Make yu follow am go meet di king. Make fear nor katch yu at-all.” So Elijah stand up kon follow am go meet di king.
2KI 1:16 Elijah tell di king, “Dis na wetin God tok, ‘Wetin make yu send pipol go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos yu tink sey Israel pipol nor get God wey yu fit ask? Bikos of dis, yu nor go stand from di bed wey yu dey so and yu must die.’ ”
2KI 1:17 Di king die just as God tok thru Elijah. For di sekond year wey Jehoshafat pikin, Jehoram bi king for Judah, Ahazaya broda wey bi Jehoram kon bi king for Israel, bikos di former king nor born boy at-all.
2KI 1:18 Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.
2KI 2:1 Time kon rish wen God won take Elijah go heaven inside betta strong breeze. Elijah and Elisha dey travel kom from Gilgal.
2KI 2:2 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait for mi, bikos God send mi go Bethel.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go Bethel togeda.
2KI 2:3 Den di profets sons wey dey Bethel kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?” Elisha ansa, “Yes! I know, but make una kwayet.”
2KI 2:4 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jeriko.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go Jeriko togeda.
2KI 2:5 Den di profets sons wey dey Jeriko kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?” Elisha ansa, “Yes! I know, but make una kwayet.”
2KI 2:6 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jordan River.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go togeda.
2KI 2:7 Fifty student wey dey go profets skool kon stand dey look Elijah and Elisha as dem stand near Jordan River.
2KI 2:8 Elijah use en garment nak di wota and di wota divide into two. Den, two of dem waka pass for dry groun.
2KI 2:9 Afta dem don waka pass, Elijah kon tell Elisha, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu, before God go take mi go heaven.” Elisha ansa, “Abeg! Make yu let mi get doubol of di pawa wey yu get.”
2KI 2:10 Elijah kon ansa, “Wetin yu ask for so, nor dey eazy. But if yu si mi wen God dey karry mi go, yu go get am, but if yu nor si mi, yu nor go get am.”
2KI 2:11 As dem dey waka dey tok dey go, one shariot with fire kom out at wons kon separate dem two. Den strong breeze kon karry Elijah go heaven.
2KI 2:12 As Elisha dey look, e kon dey shaut, “My papa, my papa, di shariot and sojas for Israel!” So e nor ever si Elijah again. Elisha kon tear en own klot to pieces.
2KI 2:13 Elisha take di garment wey fall from Elijah hand kon waka go back till e rish Jordan River wotaside.
2KI 2:14 Den e take di garment wey Elijah drop for am take nak di wota kon sey, “Where di Oga wey bi Elijah God?” Den e nak di wota again and di wota divide into two. So Elisha kon waka pass go di oda side.
2KI 2:15 Wen di fifty student from Jeriko, si Elisha dey kom, dem kon sey, “Elijah spirit don enter Elisha.” Dem waka go meet am kon bow for en front.
2KI 2:16 Den dem tell Elisha, “Fifty strong men dey here with us wey bi yor savants, abeg make yu let dem go find yor oga. May bi God Spirit don karry am go put for one mountin or valley.” But Elisha sey, “No! Make una nor send dem go.”
2KI 2:17 But di student kon dey disturb am, so e kon sey, “Make una go fine am.” Dem send fifty men go fine am for three days, but dem nor si am.
2KI 2:18 Wen dem kom back kon meet Elisha for Jeriko, e kon tell dem, “I nor warn una sey make una nor go?”
2KI 2:19 Den di men for di town tell Elisha, “Awa oga! Even doh yu si sey di town dey for betta aria, di wota bad well-well and anytin wey dem plant for di land, nor dey grow.”
2KI 2:20 Den Elisha sey, “Make una give mi one bowl kon put salt for inside.” Afta dem bring di bowl,
2KI 2:21 Elisha waka go where di wota for dey flow, pour salt put kon sey: “Dis na wetin God tok: ‘I don make dis wota good. E nor go ever kause deat or pain again.’ ”
2KI 2:22 So till today, di wota dey good, just as Elisha tok.
2KI 2:23 From Jeriko, Elisha kon go Bethel. As e dey waka for di street, some small-small boys kom outside from di town kon dey curse am dey sey, “Bololo head! Bololo head!”
2KI 2:24 So Elisha turn look dem kon curse dem with God name. Den two woman bear kom outside from di wood kon kill forty-two of di boys.
2KI 2:25 From der, Elisha go Mount Karmel, den e kon go back to Samaria.
2KI 3:1 Ahab pikin, Joram kon bi king for Israel and e rule from Samaria for twelf years and dat na di eighteen year wey Jehoshafat dey rule for Judah.
2KI 3:2 Even doh e nor gri follow God kommand, e nor bi like en papa and mama, bikos e skata di Baal juju wey en papa make.
2KI 3:3 But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.
2KI 3:4 King Mesha for Moab dey barb sheep hair and e dey always give Israel king 100,000 lamb and 100,000 rams wool,
2KI 3:5 but wen King Ahab die, Moab king kon go fight with Israel king.
2KI 3:6 So King Joram mash from Samaria go gada Israel sojas togeda.
2KI 3:7 Den e send message go meet King Jehoshafat for Judah sey: “Moab king sey en won fight mi. Yu go follow mi go fight am?” King Jehoshafat ansa, “Okay! I go follow yu, bikos as yu bi, na so I bi too. My pipol na yor pipol and my horse dem na yor own too.”
2KI 3:8 Den e ask am, “Na where wi go pass go.” King Joram ansa, “Wi go pass thru Edom Wildaness.”
2KI 3:9 So Israel, Judah and Edom kings kon dey go fight. Afta dem don waka anyhow for seven days, dia sojas and animals nor kon get wota to drink again.
2KI 3:10 Den Israel king sey, “True-true, na God bring us kom here so dat Moab King and en pipol go kill us.”
2KI 3:11 But King Jehoshafat ask, “Wi nor get any profet among us for here? Make e help us find out from God.” One of Israel king savant kon ansa, “Shafat pikin, Elisha wey bin dey pour wota for Elijah hand, dey here.”
2KI 3:12 King Jehoshafat kon sey, “True-true, God dey tok thru am.” So di three kings kon go meet am.
2KI 3:13 Elisha kon ask Israel king, “Wetin mi and yu get togeda? Make yu go meet yor papa and mama profets.” But Israel king ansa, “Nor tok like dat, bikos na God bring dis three kings togeda make Moab king and en pipol for kill us.”
2KI 3:14 Elisha kon sey, “As long as di God of all gods dey alive and as I stand for en present, if nor bi sey I dey respet King Jehoshafat, I nor for even look yor face.
2KI 3:15 But naw, make una bring one pesin wey sabi sing kom.” Wen di pesin dey sing, God spirit kon enter Elisha
2KI 3:16 and e sey, “Dis na wetin God dey tok, ‘Make una dig gutta for di wildaness;
2KI 3:17 even doh una nor go si breeze or rain, wota go full di wildaness and una with una animals go drink beleful.’ ”
2KI 3:18 Elisha still sey, “Dis tin dey eazy for God eye. E go give Moab and en pipol to una.
2KI 3:19 Den una must skata and distroy evry strong town for der. Evry good tree for der, una must kut am down kon stop and klose where wota from dey flow. All di betta land for der, una go skata dem with stones.”
2KI 3:20 Di next morning, around di time wen dem won offa di meat ofrin, wota flow kom from Edom kon full di land.
2KI 3:21 So, wen Moab pipol hear sey di kings dey kom fight dem, dem gada evribody wey fit wear soja uniform, both small and big kon go stand for di borda.
2KI 3:22 Wen dem wake-up di next morning, di sun dey shine on-top di wota and Moab pipol for di oda side si am kon sey di wota red like blood.
2KI 3:23 Dem kon sey, “Dis na blood o-o! Di kings don fight and kill each oda, so make wi go pak and take evritin wey dey dia kamp.”
2KI 3:24 But wen dem rish Israel kamp, Israel pipol kill dem well-well and di remainin ones kon dey run; but Israel pipol porshu and kill dem as dem dey run.
2KI 3:25 Dem distroy di town and each of dem kover all di good land wey dey der, with stones. Dem stop di place where wota for dey flow kon kut all di betta trees for der. Dem distroy evriwhere escept Kir-Heres wey bi di main town. Den di men wey karry katapault kon attack and distroy am.
2KI 3:26 Wen Moab king si sey di war too strong for am, e take 700 men follow body, so dat dem go fit eskape go meet Siria king, but e nor fit.
2KI 3:27 So e take en first son wey go bi king afta am kon kill-am as ofrin for God. Fear kon katch Israel pipol well-well, so dem kon go back to dia land.
2KI 4:1 One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
2KI 4:2 Elisha ask di woman, “Wetin yu wont make I do for yu?” Make yu tell mi, “Wetin yu get for yor house?” Di woman ansa, “Yor savant nor get anytin escept one small oil.”
2KI 4:3 Den Elisha tell am, “Make yu go borrow plenty empty gallon kom.
2KI 4:4 Afta yu don borrow dem, make yu enter house kon lock yor door, den pour di oil put for all di gallons and wons one full, put am for korna.”
2KI 4:5 So di woman leave am kon lock en and en sons wey bring di gallon, for inside dia house. Den e bigin pour di oil put for inside di gallons.
2KI 4:6 Wen dem don full, e kon tell en sons, “Make una bring anoda gallon kom.” But di boys ansa, “All of dem don full.” So di oil kon stop to pour kom out.
2KI 4:7 Den di woman go tell Elisha wetin happen and Elisha sey, “Go sell di oil, use di money take pay yor debt, den make yu and yor sons sell di rest kon use di money take buy food make una chop.”
2KI 4:8 One day, Elisha go Shunem, where one woman wey get money dey stay. Di woman kon sey make Elisha kom chop for en house, so wen ever Profet Elisha dey go Shunem, e go stop chop for der.
2KI 4:9 Den di woman tell en husband, “My mind dey tell mi sey, dis man wey dey always pass and kom here, na God profet e bi,
2KI 4:10 so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”
2KI 4:11 So one day, Elisha kom visit dem; den e go rest for di room for up.
2KI 4:12 E kon tell en savant Gehazi, “Make yu go koll di woman kom.” So di savant do as e tell am and di woman kon follow am kom.
2KI 4:13 Elisha tell Gehazi, “Make yu tell di woman, ‘Yu do well as yu dey kare for us, so wetin yu wont make wi do for yu? Abi yu wont make I go tell di king and en sojas oga sey yu bi good pesin?’ ” Di woman ansa, “I get evritin wey I wont, as I dey stay among my pipol.”
2KI 4:14 So Elisha tell Gehazi, “So na wetin yu wont make I do for am?” Gehazi ansa, “Dis woman nor get pikin and en husband don old.”
2KI 4:15 Elisha kon sey, “Make yu koll am kom.” So Gehazi koll am and di woman kon stand for di door-mot.
2KI 4:16 Den Elisha tell am, “For dis same time next year, yu go karry yor son for yor hand.” Den di woman ansa, “No o-o! My oga! Yu bi God profet, so make yu nor deceive mi yor savant.”
2KI 4:17 Just as Elisha don promise am, di woman get belle kon born for di time wey Elisha tok.
2KI 4:18 Di pikin kon dey grow well-well. One day, e follow en papa go farm,
2KI 4:19 den e kon dey kry give en papa sey, “My head! My head dey pain mi!” Den en papa tell en savant, “Make yu karry am go meet en mama.”
2KI 4:20 So, di savant karry am go meet en mama. Di pikin sidan for di mama leg till aftanoon, den e kon die.
2KI 4:21 So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
2KI 4:22 E koll en husband kon sey, “Abeg make yu send one among yor savant and one donkey kom, so dat I go kwik rush go meet di profet kon kom back.”
2KI 4:23 But di husband ask, “Wetin make yu wont go si am today? Today nor bi new moon or Sabat Day.” But di woman ansa, “Evritin dey okay.”
2KI 4:24 Den e enter di donkey kon tell en savant, “Make yu drive fast as yu fit drive rish, unless I sey make yu slow.”
2KI 4:25 So di woman drive go meet Profet Elisha for Mount Karmel. Wen Elisha si di woman from far, e kon tell en savant Gehazi, “Si, na dat Shunem woman dey kom so.
2KI 4:26 Make yu run go meet am kon ask am, ‘Evritin dey okay? Yor husband dey okay? Wot about yor pikin, e dey okay?’ ” Wen di savant run go meet and ask am, di woman ansa am, “Evritin dey okay.”
2KI 4:27 Wen di woman waka meet di profet on-top di mountin, e kon fall hold am for leg. Gehazi won kon porshu am komot, but di profet sey, “Leave am, dis woman dey pass thru pain and God nor let mi know before naw.”
2KI 4:28 Den di woman sey, “My oga, na mi ask yu for pikin? I know tell yu sey, ‘Make yu nor deceive mi.’ ”
2KI 4:29 So Elisha kon tell Gehazi, “Tie yor garment well make yu follow dis woman with my walkin stik. If yu meet anybody for road, make yu nor greet am and if anybody greet yu, make yu nor ansa. Den if yu rish here, take my walkin stik take tosh di pikin.”
2KI 4:30 Den di pikin mama sey, “As long as God and yu dey alive, I nor go-go without yu.” So Elisha kon follow di woman go.
2KI 4:31 Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”
2KI 4:32 Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed.
2KI 4:33 So e enter inside di room, klose di door kon pray to God.
2KI 4:34 Den e stand up kon go sleep on-top di dead body. E use en own mout take kover di boy mout, en eye for di boy eye and e hold di boy hand tie, den e stresh ensef on-top di boy and di pikin body kon warm.
2KI 4:35 Den Elisha get up kon dey waka up-and-down for di house. E waka go meet di pikin kon sleep on-top am again, den di boy kough seven times kon open en eye.
2KI 4:36 Elisha koll Gehazi kon sey, “Make yu go koll di Shunem woman kom.” So Gehazi go koll di woman. Elisha tell am, “Make yu go karry yor pikin.”
2KI 4:37 Di woman bow kon use en face tosh groun for Elisha front, den e karry en pikin kon waka komot.
2KI 4:38 Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”
2KI 4:39 So, one among dem enter di field go gada leaf and vine wey e go take kook. Wen e kom back, e kut dem put for di stew, but dem nor know wetin dem dey do or wish kind leaf e bi.
2KI 4:40 Dem serve some give di men make dem chop, but as dem chop di stew, dem kon shaut dey sey, “Profet! Dis pot of stew go kill us o-o!” So dem nor fit chop am.
2KI 4:41 Den Elisha sey, “Make una give mi some flower.” E pour di flower inside di pot kon sey, “Serve some give di men make dem chop.” So di food kon dey good to chop.
2KI 4:42 Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”
2KI 4:43 But Elisha savant sey, “Make I give twenty bread to dis hundred men?” Elisha ansa, “Give am to di pipol make dem chop, bikos God sey, ‘Dem go chop taya and di food go remain.’ ”
2KI 4:44 So e give di pipol and just as God tok, dem chop beleful and some still remain.
2KI 5:1 E get one man wey en name na Naaman and na-im bi Siria sojas oga. Siria king like and dey respet am well-well, bikos thru am, God don make Siria pipol win many war. Naaman sabi fight well-well, but e get one kind diziz for body.
2KI 5:2 So, wen Siria sojas go fight war for Israel, dem katch one small girl kon gi-am to Naaman wife, as en savant.
2KI 5:3 One day, di girl kon tell en madam, “If to sey my oga go gri go meet di profet for Samaria, e go fit cure am from dis diziz.”
2KI 5:4 So Naaman go tell di king wetin di Israel girl tok.
2KI 5:5 Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot.
2KI 5:6 E take di leta go give Israel king wey sey: “Dis leta na to let yu know sey na mi send my savant, Naaman kom meet yu, so dat yu go heal am from en sickness.”
2KI 5:7 Wen Israel king read di leta, e tear en klot kon sey, “Na mi bi God wey get pawa to give and take life? Wetin make di king tink sey I go fit cure dis man? If yu tink am well-well, yu go si sey e dey find as e go take fight mi.”
2KI 5:8 Wen Elisha, God profet hear sey di king tear en klot, e kon send pipol go meet and tell di king, “Wetin make yu tear yor klot? Send am kom meet mi and e go know sey Israel really get betta profet wey God send kom.”
2KI 5:9 So Naaman with all en men go meet and stand for Elisha door-mot.
2KI 5:10 Elisha sey make en savant go tell Naaman, “Make yu go wosh yorsef seven times for Jordan River, den yu go well.”
2KI 5:11 But Naaman vex waka komot dey sey, “I bin tink sey e go kom outside kom meet mi, den koll en God name and wave en hand for di diziz, so dat I go well.
2KI 5:12 Amanah and Farpar for Damaskus nor betta pass all di rivers for Israel? Why e nor send mi go one of dem, so dat I go well?” So Naaman vex komot from der.
2KI 5:13 Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.”
2KI 5:14 So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.
2KI 5:15 Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
2KI 5:16 But Elisha ansa, “God Forbid! As long as di Oga God wey I dey serve dey alive, I nor go take anytin from yu.” Naaman beg am well-well, but e nor gri.
2KI 5:17 So Naaman sey, “Since yu nor gri take anytin, abeg make yu give us two donkey wey wi go use take pak una san go awa land, bikos I nor go ever offa any ofrin give any oda god escept yor God.
2KI 5:18 I pray make God forgive mi for dis tins: Wen my oga wey bi Siria king dey go woship en juju Rimmon for en temple, I go nid to follow am go, bikos na mi bi en rite-hand-man. But make God forgive mi even as I go bow to Rimmon for di temple.”
2KI 5:19 So Elisha tell am, “Make peace follow yu as yu dey go.” Afta Naaman don travel small,
2KI 5:20 Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”
2KI 5:21 So Gehazi porshu Naaman. Wen Naaman si sey pesin dey run kom meet am, e kom down from en horse kon ask, “Hope evritin dey okay?”
2KI 5:22 Gehazi ansa, “Yes! Evritin dey okay. Na my oga send mi kom meet yu sey, ‘Two of di profets savant just kom meet mi from Efraim hill kountry. So make yu give dem silva wey heavy rish seventy-five pounds and two difren klot.’ ”
2KI 5:23 So Naaman ansa, “Abeg make yu take silva wey heavy rish one hundred and fifty pounds.” E beg Gehazi well-well kon pak am inside two bags with two difren klot. Naaman give dis tins to two of en savant make dem karry am follow Gehazi.
2KI 5:24 Wen Gehazi rish di hill, e karry di gift from dem kon keep am for en house. Den e tell di men make dem dey go, so dem kon go.
2KI 5:25 Leta wen Gehazi go stand near en masta, Elisha kon ask am, “Gehazi, where yu go since?” Gehazi ansa, “I nor go anywhere o-o.”
2KI 5:26 Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.
2KI 5:27 Bikos of dis tin wey yu do so, Naaman diziz go katch yu and yor shidren-shidren forever.” So wen Gehazi komot from Elisha front, di diziz kon katch am and en body kon dey white like snow.
2KI 6:1 Some profet kon tell Elisha “Si, di place where wi dey stay too small for us.
2KI 6:2 So make wi go Jordan aria where wi go for get and kut betta wood kon build betta house for awasef for der.” Elisha ansa dem, “Make una go.”
2KI 6:3 But one of dem tell am, “Abeg oga, make yu follow us go.” So Elisha ansa, “Okay, I go follow una.”
2KI 6:4 So e follow dem go. Wen dem rish Jordan, dem kon start to kut trees down.
2KI 6:5 As dem dey kut, one of dem axe head kon fall enter Jordan river. Den e shaut, “My oga, I don die. Na borrow I borrow dis axe o-o!”
2KI 6:6 So Elisha ask, “Na wish side e fall put?” So di man show am where e fall put, den Elisha kut small branches for di tree kon drop am put for der, den di axe head kon float kom up.
2KI 6:7 Elisha tell di man, “Make yu pick di axe komot from di wota.” So di man kon pick am.
2KI 6:8 Naw, Siria pipol kon dey fight Israel pipol. Siria king kon koll doz wey dey advise am and dem tell am where and wen e go take attack.
2KI 6:9 But Elisha sey make dem go tell Israel king sey, “Make yu nor pass thru dis place, bikos Siria king go attack der.”
2KI 6:10 So Israel king send message go meet en men about wetin Elisha tok and e warn dem well-well. Nor bi only wons dis tin happen.
2KI 6:11 Di tin kon make Siria king dey vex well-well. So e koll all doz wey dey advise am kon sey, “E bi like sey one of us dey help Israel king.”
2KI 6:12 One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
2KI 6:13 So di king sey, “Make una go find out where e dey, so dat I go send men go katch am kom.” Leta, dem kon tell di king, “Elisha dey for Dotan.”
2KI 6:14 So e send strong sojas and horse make dem go katch Elisha kom. Dem rish der for nite kon surround di town.
2KI 6:15 Wen Elisha savant get up for early morning go outside, e kon si sey sojas surround di town with dia horse. Den e go tell Elisha, “Oga! Na die wi dey so o-o, wetin wi go do naw?”
2KI 6:16 Elisha ansa, “Make yu nor fear, bikos di ones wey dey with us, many pass di ones wey dey with dem.”
2KI 6:17 Den Elisha kon pray, “Oga God, make Yu open my savant eye, so dat e go si for ensef.” So God open di savant eye, so e kon si sey many horse with fire kover di mountins wey surround Elisha.
2KI 6:18 As Siria sojas dey kom, Elisha kon pray, “Oga God, make yu blind all dis pipol eye.” So God make dem blind, just as Elisha ask.
2KI 6:19 Den Elisha tell dem, “Dis nor bi di rite road or town. Make una follow mi and I go take una go meet di man wey una dey find.” So e karry all of dem go Samaria.
2KI 6:20 Wen dem don enter Samaria, Elisha kon sey, “My Oga God, make Yu open dia eye, so dat dem go si.” So God open dia eye and dem kon si sey dem dey inside Samaria.
2KI 6:21 Wen Israel king si dem, e kon ask Elisha, “My oga, make I kill all of dem?”
2KI 6:22 Elisha ansa, “Nor kill dem! Yu nor katch dem with yor swod or arrow, so who give yu di pawa to kill dem? Make yu give dem food chop and wota drink, den make dem go back go meet dia oga.”
2KI 6:23 So di king do big party for dem and dem chop and drink. Den e send dem go back go meet dia oga. Afta dat, no soja for Siria ever kom fight against Israel pipol again.
2KI 6:24 Leta, King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas go surround and attack Samaria.
2KI 6:25 Bikos of wetin dey happen so, Samaria pipol food kon finish and dem kon dey sell donkey head for eight silva and half pound for dove shit kon bi five silva.
2KI 6:26 As Israel king dey strol pass di town wall, one woman kon shaut, “My king, make yu help us o-o!”
2KI 6:27 Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”
2KI 6:28 Den di king ask di woman, “Wetin bi yor problem?” Di woman ansa, “One woman sey, ‘Make yu give mi yor pikin make wi chop today, den wi go chop my own tumoro.’
2KI 6:29 So wi boil my pikin chop. Di next day, I kon tell am, ‘Bring yor pikin make wi chop,’ but e nor gri!”
2KI 6:30 Wen di king hear wetin di woman tok, e tear en klot. As di king dey waka pass di town wall, di pipol kon si sey e wear sak klot.
2KI 6:31 Den di king sey, “Make God ponish mi if I nor kut Shafat pikin, Elisha head komot before today go end!”
2KI 6:32 By dis time, Elisha sidan for en house with di kommunity leaders. Di king kon send pesin go for front, but before e rish der, Elisha tell di leaders, “Una nor know sey di pesin wey di king send dey kom kut my head komot? So, wen e rish here, make una lock di door, so dat e nor go enter, bikos en oga dey kom for back.”
2KI 6:33 E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
2KI 7:1 Elisha ansa, “Make una hear God word, ‘By dis time tumoro, three kilogram for di best flower and six kilogram for barley, una go dey buy dem with one silva.’ ”
2KI 7:2 One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”
2KI 7:3 Four men wey get diziz for body, sidan for di town gate. So dem tell demsef, “Wetin make us just sidan for here dey wait di time wey wi go die?
2KI 7:4 If wi enter di town, hongry go kill us and if wi stay here, hongry go still kill us! So make wi go Siria sojas kamp. Di highest wey dem fit do, na to kill us, but may bi dem go fit still sorry for us.”
2KI 7:5 So, as day dey dark, dem kon go Siria sojas kamp, but wen dem rish der, dem nor si anybody,
2KI 7:6 bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”
2KI 7:7 So dat evening, Siria sojas run leave dia kamp, horse, donkey and evritin wey dem get for di kamp.
2KI 7:8 Wen di four men rish di kamp door-mot, dem enter di tent, chop and drink beleful kon kollect and go hide di silva, gold and klot wey dem si. Den, dem enter anoda tent kon do di same tin.
2KI 7:9 Den dem tell each oda, “Wi nor suppose to dey do like dis! Wi get betta news and wi must go tell awa pipol. If wi wait until tumoro morning before wi tok, di king go ponish us. So make wi go naw go tell di king ofisas!”
2KI 7:10 So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.”
2KI 7:11 Di guards announce di news and dem kon go tell di king.
2KI 7:12 By dat time, day don dark well-well, but di king tell en ofisas, “I go tell una wetin Siria sojas dey plan! Dem know sey honga one kill us, so dem don leave dia kamp go hide, bikos dem dey hope sey, wi go leave awa town go find food for dia kamp, den dem go katch us alive kon konker dis town.”
2KI 7:13 One of di ofisas ansa, “Di pipol wey dey di town don taya already, bikos dem bi like pipol wey don already die. So make wi send some men with five horse from di ones wey remain for di town. (Even if dem kill dem, na di same tin go still happen to evribody wey dey Israel, bikos all of us go still die!) Make wi send dem go, so dat wi go really know wetin dey happen.”
2KI 7:14 So dem choose some men and di king kon send dem go with two shariot sey, “Make una go look wetin happen to Siria sojas.”
2KI 7:15 As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.
2KI 7:16 Den Samaria pipol rush enter Siria kamp kon pak evritin wey dey der. And as God tok, three kilogram for di best flower or six kilogram for di best korn, dem kon dey sell am for one silva.
2KI 7:17 So Israel king put en own offisa as guide for di town gate. But di pipol mash am die for der, just as Elisha tell di savant wen di king kom meet am.
2KI 7:18 Elisha don tell di king before sey by dis time tumoro for Samaria gate, dem go dey sell three kilogram for di best flower and six kilogram for di best korn for one silva
2KI 7:19 and dat ofisas bin ansa sey, “E nor fit happen, even if God ensef go send korn kom naw-naw!” And Elisha tell am, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from di food.”
2KI 7:20 And dat na wetin just happen to di man. Pipol mash am die for di town gate.
2KI 8:1 So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.”
2KI 8:2 So di woman do as di profet tell am. En and en family kon go stay for Filistia land for seven years.
2KI 8:3 Afta dat time, di woman kom back from Filistia kon go meet di king make e gi-am en house and land back.
2KI 8:4 For dis time, di king tell Gehazi wey bi di profet savant sey, “Make yu tell mi all di wonderful tins wey Elisha don do.”
2KI 8:5 As Gehazi dey tell di king how Elisha take wake pesin wey don die, di woman wey Elisha wake en pikin, waka kom ask di king about en house and lands. So Gehazi sey, “My oga di king, dis na di woman and en son wey Elisha wake from deat!”
2KI 8:6 Di king ask di woman weda di story na trut and di woman kon tell am evritin. So di king tell one of en kourt ofisas sey make e kare for di woman, den e orda dem, “Make una give dis woman en house and land back, plus di money for evry fruit wey di land produce from di day wey e komot from dis town kom rish naw.”
2KI 8:7 Elisha travel go Damaskus wen King Ben-Hadad for Siria nor well. Dem kon tell di king, “Di profet don kom.”
2KI 8:8 So di king tell Hazael, “Make yu take gift go give di profet. Tell am make e help yu ask God, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
2KI 8:9 Den Hazael kon go visit Elisha. E karry gift and forty kamel wey full with all di fine-fine tins wey dey Jerusalem follow body. Wen e rish der, e stand for di profet front kon sey, “Na yor pikin, King Ben-Hadad for Siria send mi kom ask yu sey, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
2KI 8:10 Elisha ansa, “Go tell am sey God don show mi sey e go really die, but dis sickness nor go kill-am.”
2KI 8:11 Elisha kon dey look Hazael one kind, sotey Hazael kon konfuse. Den di profet start to kry.
2KI 8:12 Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”
2KI 8:13 Hazael ansa, “How e won take happen, bikos I nor even betta rish dog?” Elisha ansa, “God don show mi sey yu go bi Siria king.”
2KI 8:14 So Hazael leave Elisha kon go back to en house. King Ben-Hadad ask am, “Wetin Elisha tok?” Hazael ansa, “E sey yu go well again.”
2KI 8:15 Di next day Hazael take small klot, put am for wota kon use am dey tosh Ben-Hadad face until e die. Den Hazael kon bi Siria king.
2KI 8:16 For di fift year wen Joram, Ahab pikin dey rule for Israel, Jehoshafat pikin Jehoram kon bi king for Judah.
2KI 8:17 E bi thirty-two years wen e start to rule and e rule for eight years for Jerusalem.
2KI 8:18 E rule as di oda kings for Israel, en wife na Ahab pikin and just like Ahab family, en too join for di wiked tins wey Israel king dey do. E sin against God,
2KI 8:19 but God nor won distroy Judah. E keep Judah, bikos of di promise wey E don make with David en savant.
2KI 8:20 Wen e dey rule, Edom pipol free demsef from Judah kon get dia own king.
2KI 8:21 King Jehoram cross go Zair with en men. Edom pipol surround and attack am for nite kon win en and en men, den Israel sojas run go back to dia land.
2KI 8:22 So till today, Edom pipol dey free from Judah hand. For dat time, Libnah pipol still kause wahala too.
2KI 8:23 Di remainin tins wey Jehoram do, plus evritin wey e build, dem rite dem for Judah kings history book.
2KI 8:24 Jehoram die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Ahazaya kon take-ova as king.
2KI 8:25 For di twelft year wey Ahab pikin, Joram dey rule Israel, Jehoram pikin, Ahazaya kon bi king for Judah.
2KI 8:26 Ahazaya na twenty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for one year. En mama name na Atalaya wey bi King Omri for Israel grand-pikin.
2KI 8:27 Bikos Ahazaya na family memba to Ahab thru marriage, en too sin against God, just like Ahab family.
2KI 8:28 King Ahazaya join King Joram for Israel go fight King Hazael for Siria for Ramot for Gilead where Siria pipol for win and wound King Joram for di fight.
2KI 8:29 King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.
2KI 9:1 Naw, Elisha koll one among di profet sons kon sey, “Wear yor klot, den take dis olive oil kontaina go Ramot for Gilead.
2KI 9:2 Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room.
2KI 9:3 Take di olive oil, pour am for en head kon sey, ‘Dis na wetin God tok, “I don choose yu as Israel king.” ’ Den make yu kwik-kwik komot from der!”
2KI 9:4 So di profet pikin kon go Ramot for Gilead.
2KI 9:5 Wen e rish der, Jehu wey bi di sojas oga, sidan for der. So e sey, “Offisa, abeg, I get message for yu.” Jehu kon ask, “Na wish one of us yu dey tok to?” E ansa, “Oga, na yu.”
2KI 9:6 So Jehu stand up, follow am go inside. Den di profet pour di olive oil for en head kon sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I don choose yu as Israel king.
2KI 9:7 Yu go distroy yor oga, Ahab family. I go revensh Jezebel bikos of my savants, di profets wey e kill.
2KI 9:8 Evribody for Ahab family go die finish. Evry son wey dey Ahab family for Israel, I go kill all of dem, both di ones wey dey free and di ones wey bi slave.
2KI 9:9 As I do Jeroboam, Nebat pikin and Baasha, Ahijah pikin with dia shidren-shidren, na so too I go distroy Ahab shidren-shidren.
2KI 9:10 Dogs go chop Jezebel for Jezrel land and nobody go beri am.’ ” Den di yong profet kon kwik-kwik komot der.
2KI 9:11 Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”
2KI 9:12 But dem sey, “Yu dey lie! Make yu tell us wetin e tok.” Jehu ansa, “E tell mi sey, God tok sey: ‘I don choose yu to bi king for Israel.’ ”
2KI 9:13 So each of dem kwik-kwik remove dia klot kon spread dem put for Jehu leg for di step. Dem blow di trumpet kon shaut sey, “Na Jehu bi king!”
2KI 9:14 Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria.
2KI 9:15 So Jehu tell di oda ofisas, “If una dey with mi, make una make sure sey nobody komot from Ramot go warn Jezrel pipol.”
2KI 9:16 Den Jehu enter en horse kon go Jezrel, bikos dem dey trit Joram for der. (For dis time, King Ahazaya for Judah don kom visit Joram.)
2KI 9:17 Naw, di gateman stand for di gate for Jezrel kon si Jehu men dey kom. So e sey, “I si some men dey kom!” King Joram kon orda sey, “Make yu send one pesin go mi dem kon ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
2KI 9:18 So dem send one man go meet Jehu kon ask, “Di king dey ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ” Jehu ansa, “E nor koncern yu, just follow mi.” Di gateman kon go tell di king, “I send pesin go, but e neva kom back.”
2KI 9:19 So e send anoda pesin go ask, “Dis na wetin di king ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ” Jehu ansa dis one too sey, “E nor koncern yu, just follow mi.”
2KI 9:20 Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”
2KI 9:21 King Joram kon sey, “Make una ready my horse.” Wen dem don ready en horse, King Joram for Israel and King Ahazaya for Judah kon enter dia horse go meet Jehu. Dem meet am for one land wey bi Nabot for Jezrel own before.
2KI 9:22 Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?” Jehu ansa, “How evritin won take dey okay wen yor mama still dey make pipol serve juju and do oda bad tins.”
2KI 9:23 King Joram kon tell King Ahazaya sey, “Na plan work!” Den e turn en horse kon dey run.
2KI 9:24 Jehu karry en bow and arrow kon shot King Joram and di arrow enter en heart, so e fall from en horse kon die.
2KI 9:25 Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,
2KI 9:26 ‘I si as una kill Nabot and en sons yestiday. And I promise sey I go still ponish yu for dis same land.’ So make una trow di body for di field, so dat wetin God tok, go happen.”
2KI 9:27 Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.
2KI 9:28 En offisa karry en body go back to Jerusalem kon beri am with en grand-grand papa dem for David Town.
2KI 9:29 Ahazaya na king for Judah for eleven years wen Joram, Ahab pikin dey rule.
2KI 9:30 Jehu kon ride dey go Jezrel. Wen Jezebel hear wetin happen, e paint en eye, do en hair well kon dey look from di window.
2KI 9:31 As Jehu enter thru di gate, Jezebel kon sey, “Zimri, yu wey kill yor oga! Hope evritin dey okay? Wetin yu dey do for here?”
2KI 9:32 Jehu look up kon shaut, “Na who dey my side?” Like two or three kourt ofisas look am from di window.
2KI 9:33 So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.
2KI 9:34 Jehu enter di palis kon sidan chop for der. Den e sey, “Make una go trowey dis wiked woman dead body. Make una beri am, bikos na king pikin e bi.”
2KI 9:35 But wen dem won go beri Jezebel, dem nor si anytin escept en skull, leg and hand.
2KI 9:36 Dem kon go back go tell Jehu wetin happen, den e sey, “All wetin God tok thru en savant Elijah wey kom from Tishbe, don really happen. Bikos Elijah warn dem sey, ‘Na for Jezrel land, dogs go for chop Jezebel flesh kon lick en blood.
2KI 9:37 Wetin remain for Jezebel body, go skata like dirty for Jezrel land and pipol nor go fit know am at-all.’ ”
2KI 10:1 Ahab get seventy sons for Samaria. So Jehu rite and send leta go give di sojas oga and doz wey dey guide Ahab shidren. Dis na wetin e rite for di leta:
2KI 10:2 “Since, una oga sons, horse, fine towns and weapon, dey with una, wen dis leta rish una hand,
2KI 10:3 make una pick one from una oga pikin wey fit fight kon make am king, so dat una go fit fight for una oga shidren.”
2KI 10:4 Dem fear well-well kon sey, “Si! If two kings nor fit stop yu! How wi won take stop yu?”
2KI 10:5 So di pesin wey dey look di palis, di leader for di town, di eldas and di guards kon send dis message go meet Jehu sey, “Wi bi yor savants! Wi go do anytin wey yu tok. Wi nor go fit crown anybody. Make yu just do wetin yu know sey dey good.”
2KI 10:6 Jehu rite anoda leta go give dem sey, “If una really dey my side and una ready to obey mi, den tumoro, make una karry una oga sons head kon meet mi for Jezrel.” King Ahab born seventy sons and na doz wey dem respet well-well for di town, dey kare for di sons.
2KI 10:7 Wen dem receive di leta, dem katch di king sons kon kill all of dem. Dem put dia heads for basket kon send am go meet Jehu for Jezrel.
2KI 10:8 Di messenja kon tell Jehu, “Dem don bring di king sons head kom.” Jehu ansa, “Make yu hang dem put for two stik for di town gate till tumoro morning.”
2KI 10:9 For morning, Jehu go stand near di head dem. Den e kon tell all di pipol, “I gri sey una nor do anytin, bikos na mi set trap for my oga di king kon kill-am. But na who kill all dis men?
2KI 10:10 So dis show sey evritin wey God tok about Ahab and en family, must happen. God don do wetin E tok thru en savant, Elijah.”
2KI 10:11 Den Jehu kill di odas for Ahab family wey dey Jezrel, plus all en ofisas, klose friends and priests. E nor leave any one.
2KI 10:12 Jehu leave der kon go Samaria. As e dey travel pass Bet-Eked (where doz wey dey guide sheep dey kamp put),
2KI 10:13 Jehu meet some pipol wey rilate to King Ahazaya for Judah. Jehu kon ask dem, “Who una bi?” Dem ansa, “Wi bi King Ahazaya family membas. Wi dey go Jezrel go greet Kween Jezebel and di odas for di palis.”
2KI 10:14 Jehu kon sey, “Make una katch dem kom!” So dem katch dem and Jehu kill all of dem for Bet-Eked pit, (na forty-two dem bi).
2KI 10:15 Wen e komot from der, e meet Jehonadab, Rekab pikin wey dey find am since. Jehu greet am kon ask, “Yu get respet for mi, just as I get for yu?” Jehonadab ansa, “Yes, I dey respet yu!” Jehu kon sey, “If na so, den shake mi.” So Jehonadab stresh en hand and Jehu kon karry am enter en horse.
2KI 10:16 Jehu kon tell am, “Follow mi, so dat yu go si how I dey sirious about God work.” So Jehu karry Jehonadab follow body.
2KI 10:17 E go Samaria kon kill all Ahab family wey remain, just as God don tok thru Elijah.
2KI 10:18 Jehu gada all di pipol kon tell dem, “King Ahab woship juju small; but Jehu go woship juju well-well.
2KI 10:19 So make una koll all di juju profets sey make dem kom meet mi, plus all dia savants and priests. All of dem must present, bikos I won offa betta sakrifice give di juju. Anybody among dem wey nor gri kom, I go kill-am.” But Jehu dey deceive dem, so dat e go fit kill all of dem wey dey serve juju.
2KI 10:20 Den Jehu orda sey, “Make una go arrange big feast for Baal juju.” So dem kon announce am.
2KI 10:21 Jehu invite all di pipol wey dey serve juju for Israel and all of dem kom di party. Pipol full di juju temple from front go rish back.
2KI 10:22 Jehu orda di pesin wey dey keep di garments, “Make yu give garment to all dis pipol.” So, e bring garment kom for dem.
2KI 10:23 Den Jehu and Rekab pikin, Jehonadab kon go di juju temple. Jehu tell di pipol, “Make una make sure sey nobody wey dey serve God dey here with una; bikos na only doz wey dey serve juju must dey here.”
2KI 10:24 Dem kon go inside, so dat dem go offa sakrifice kon burn ofrin. By dis time, Jehu don pozishon eighty men for outside and e warn dem sey, “If any of dis men wey dey inside eskape, una go pay with una life!”
2KI 10:25 Wen e don offa di sakrifice finish, Jehu kon tell di guards for di palis, “Make una enter inside di temple go kill all of dem and make no one eskape!” Di guards and ofisas kill all of dem for der kon trow dia body for outside, den dem waka enter inside di main room for di juju temple.
2KI 10:26 Dem bring di pila for di juju temple kom outside kon burn dem.
2KI 10:27 Dem break di juju image and en house and na der pipol dey shit put kon rish today.
2KI 10:28 So Jehu stop juju woship for Israel.
2KI 10:29 But Jehu kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin, wey make Israel sin as dem dey woship di juju wey dey Bethel and Dan.
2KI 10:30 God kon tell Jehu, “Evritin wey I won make yu do to Ahab family, yu don do am. So I promise yu sey yor shidren-shidren go bi king for Israel from naw go rish di fourt generashon.”
2KI 10:31 But Jehu nor obey di Oga, Israel God with en whole heart; instead e kon dey sin like Jeroboam wey make Israel sin.
2KI 10:32 For dat time, God kon dey reduce di land wey Israel pipol get. King Hazael for Siria kollect Israel pipol land
2KI 10:33 from Jordan River east go rish di sout towns for Aroer for River Arnon, plus Ramot and Bashan for where Gad tribe, Reuben tribe and East Manasseh tribe dey stay.
2KI 10:34 Evry oda tin wey Jehu do, plus all en mighty-mighty works, dem rite dem put for Israel kings history book.
2KI 10:35 King Jehu die and dem beri am for Samaria and en son Jehoahaz kon take-ova as king.
2KI 10:36 Jehu rule from Samaria as king for Israel for twenty-eight years.
2KI 11:1 Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family.
2KI 11:2 So King Joram dota, Jehosheba, wey bi Ahazaya sista, eskape with Ahazaya pikin, so dem nor kill-am with di oda king shidren. Jehosheba keep di boy with en nurse for one room where dem dey keep tins inside di temple, so dat Atalaya nor go fit si and kill-am.
2KI 11:3 Di boy dey inside God temple for six years, wen Atalaya dey rule.
2KI 11:4 Den for di sevent year, Jehoiada wey bi di priest kon send message sey make dem koll di sojas and di guards oga kom meet am for di temple, where e for make kovenant and swear with dem. Den e show dem di king pikin
2KI 11:5 kon kommand dem sey, “Dis na wetin una go do. Una wey dey kom work for Sabat Day, make una divide unasef into three group. One part go dey protet di king palis,
2KI 11:6 anoda part go dey for di Sur Gate and di last part go dey di gate wey dey di guards back. Una go choose as una go take dey kom guide di palis.
2KI 11:7 Di remainin two part wey nor dey work for Sabat Day, go dey protet God Temple.
2KI 11:8 Una must always dey guide di king with una bow, arrow and spear. And make una kill anybody wey waka anyhow kom di aria where di king dey. Wen ever di king dey do anytin, una must dey with am.”
2KI 11:9 So di sojas oga kon do evritin, just as Jehoiada kommand dem. E bring all en men kom, both doz wey dey work for Sabat Day and doz wey nor dey work.
2KI 11:10 Jehoiada kon give di sojas oga, King David spear and shield wey dey God Temple.
2KI 11:11 Di guide hold dia swod, bow, arrow and spear as dem dey guide di temple where di king dey; dem dey guide evriwhere from rite to left and from di altar go rish di temple.
2KI 11:12 Jehoiada bring di king pikin kom out kon crown and gi-am God laws. Den dem make am king, anoint am kon klap dey sey, “God save di king!”
2KI 11:13 Wen Atalaya hear di royal guide dey shaut, e kon go meet di pipol for God Temple.
2KI 11:14 Den Atalaya look well kon si di king stand near di pila akordin to dia tradishon. Doz wey dey kommand and blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land dey happy kon dey blow trumpet. Atalaya tear en klot kon sey, “Dis na plan work! Una really plan dis one o-o!”
2KI 11:15 Den Jehoiada kon tell di sojas, “Make una karry Atalaya go meet di guards for outside. Make una kill anybody wey won stop una.” Di priest give dis orda, so dat dem nor go kill Atalaya inside di Temple.
2KI 11:16 Dem hold and drag Atalaya pass where horse dey for di king palis kon kill-am for der.
2KI 11:17 Den Jehoiada with di king and di pipol kon make kovenant sey, na only God dem go always dey serve.
2KI 11:18 Di pipol kon go skata dia juju, di juju house dem and en altar. Dem kill Mattan wey bi di juju priest for di altar front. Jehoiada kon put guards for di Temple.
2KI 11:19 So, en, di sojas oga, di guards oga and di pipol kon take di king from di Temple go di palis thru di royal bodyguard gate, den di king kon sidan for di throne.
2KI 11:20 Evribody for di land bigin happy, bikos peace kon dey di land afta dem kill Atalaya for di royal palis.
2KI 11:21 Jehoash na seven years wen e stay to rule.
2KI 12:1 For di sevent year wen Jehu dey rule, Jehoash kon bi king; e rule Judah for forty years from Jerusalem. En mama na Zibaya wey kom from Beersheba.
2KI 12:2 Thru-out di time wey Jehoash dey rule, e do as God kommand, just as Priest Jehoiada tish am.
2KI 12:3 But e nor skata di juju place dem; so di pipol still dey go offa sakrifice and burn incense for der.
2KI 12:4 Jehoash tell di priests, “All di silva wey dey God Temple, di ones wey dem kollect wen dem dey kount di pipol, all di silva wey dem kollect as vow and di ones wey pipol just drop on dia own, make una use dem ripair di Temple.
2KI 12:5 Make una kollect di money from doz wey dey keep am kon ripair anywhere wey spoil for di Temple.”
2KI 12:6 For di twenty-three years wen Jehoash don bi king, di priests neva still ripair where spoil for di Temple.
2KI 12:7 So King Jehoash koll Jehoiada with oda priests kon sey, “Wetin make una neva ripair where spoil for di Temple? Naw, make una nor take any money again escept una won use am ripair di Temple.”
2KI 12:8 Di priests dem gri sey dem nor go kollect money from di pipol, so dat nobody go akuiz dem sey dem nor ripair di Temple.
2KI 12:9 But Jehoiada take one box kon kut hole put for en top and put am for di rite side for di altar where dem dey pass enter God house. Den di priest wey dey di temple gate, go pak and put all di money inside di box.
2KI 12:10 Wen dem si sey di box don full, di royal seketry and di High Priest go kount and keep di money.
2KI 12:11 Den dem give di money to di pesin wey dey ripair di Temple. Dem hire karpenters and builders wey go work for di Temple,
2KI 12:12 plus brick-laya and doz wey dey kut stone. Dem bring wood and chisel wey dem go take ripair di part wey spoil for di Temple kon pay for evry oda tin.
2KI 12:13 Di money wey dem bring kom God Temple, dem nor use am for silva bowl, wetin dem take dey burn incense, basins, trumpets or anytin wey bi gold or silva.
2KI 12:14 Dem give di money to di workers wey go ripair God Temple.
2KI 12:15 Di pesin wey dey pay di workers, dem nor ask am how e take dey spend di money, bikos dem trust and bilive am.
2KI 12:16 (Di money wey dem kollect, plus di ripair and sin ofrins, dem nor bring dem kom God Temple, bikos na di priests own.)
2KI 12:17 For dat time, King Hazael for Siria kon attack and seize Gat. Hazael still attack Jerusalem.
2KI 12:18 King Jehoash for Judah kollect all di holy tins wey en grand-grand papa Jehoshafat, Jehoram and King Ahazaya keep for di Temple for Judah, plus di holy tins wey en ensef keep and all di gold wey dey for God Temple and di king palis kon send dem go give King Hazael for Siria, so dat e nor go kom attack Jerusalem again.
2KI 12:19 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite dem for Judah kings history book.
2KI 12:20 En ofisas plan kon kill-am for Bet-Millo for di road wey face Silla.
2KI 12:21 Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
2KI 13:1 For di twenty three year wen King Joash, Ahazaya pikin dey rule Judah, Jehoahaz wey bi Jehu pikin kon bi king for Israel. E rule from Samaria for seventeen years.
2KI 13:2 E nor obey God. E dey wiked like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 13:3 God vex for Israel pipol kon make dem serve King Hazael for Siria and en son Ben-Hadad, for many years.
2KI 13:4 Jehoahaz kon tell God make E forgi-am and God ansa en prayer, bikos E si sey King Hazael really dey sofa Israel pipol.
2KI 13:5 God diliver Israel pipol and dem kon dey free from Siria king. So Israel pipol kon dey live for peace.
2KI 13:6 But just like Jeroboam family, dem nor gri turn from sin kon meet God. Dem even make Asherah juju for Samaria.
2KI 13:7 King Jehoahaz nor get any sojas, escept fifty men wey fit use horse, ten shariot and 10,000 sojas for groun. Siria king don kill and mash all en men like san-san.
2KI 13:8 Di remainin tins wey Jehoahaz do, plus all wetin e get, dem rite dem for Israel kings history book.
2KI 13:9 Jehoahaz die and dem beri am for Samaria. En pikin Jehoash kon take-ova as king.
2KI 13:10 For di thirty-seven year wey King Joash dey rule Judah, Jehoahaz pikin, Jehoash kon bi king for Israel. E rule from Samaria for sixteen years.
2KI 13:11 E nor obey God kommand. E bad like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 13:12 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.
2KI 13:13 Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with di kings for Samaria.
2KI 13:14 Wen Elisha dey sick di sickness wey finally kill-am, Jehoash wey bi Israel king go visit am kon dey kry for en front sey, “My papa! My papa! Di shariot and soja for Israel!”
2KI 13:15 Elisha tell am, “Make yu go take bow and arrow.” So e take bow and arrow.
2KI 13:16 Den Elisha tell Israel king, “Target with di bow.” Di king kon do am. Den Elisha put en hand on-top di king hand
2KI 13:17 kon sey, “Make yu open di window face east.” So di king do as di profet tell am. Elisha kon sey, “Make yu shot!” So di king kon shot. Elisha tell am again, “Dis arrow mean di viktory wey God won give yu ova Siria king and en pipol. Yu go distroy Siria for Afek!”
2KI 13:18 Den Elisha sey, “Take di arrow!” So di king take am. E tell di king, “Nak di groun with am!” Di king nak di groun three times kon stop.
2KI 13:19 Di profet vex kon tell di king, “If to sey yu nak di groun rish five or six times, yu for distroy Siria finish! But naw, na only three times yu go win Siria.”
2KI 13:20 So Elisha die and dem kon beri am. But as anoda year dey start, Moab pipol kon attack di land.
2KI 13:21 One day, some men dey beri pesin wen dem si some pipol dey kom attack dem. So dem kon trow di dead body inside Elisha grave. As di dead body tosh Elisha bone, di man wey don die kon wake-up.
2KI 13:22 So, thru-out di time wen Jehoahaz dey rule Israel, King Hazael for Siria dey opress dem.
2KI 13:23 But God look Israel pipol kon sorry for dem. God help dem, bikos of di promise wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. Till today, E nor like to distroy or remove dem from en present.
2KI 13:24 Wen King Hazael for Siria die, en pikin Ben-Hadad kon take-ova as king.
2KI 13:25 Jehoash wey bi Jehoahaz pikin kon kollect all di land wey Ben-Hadad papa, Hazael, don take from en papa hand for war. Jehoash win three times kon kollect all di land and towns wey bi Israel pipol own.
2KI 14:1 For di sekond year wen Jehoahaz pikin, King Joash dey rule Israel, Joash pikin, Amazaya kon bi king for Judah.
2KI 14:2 E bi twenty-nine years wen e start to rule from Jerusalem. Na Jehoaddin wey kom from Jerusalem bi en mama.
2KI 14:3 E do wetin God kommand, but nor bi as en grand-grand papa David do. E follow en papa Joash, ezample.
2KI 14:4 But e nor distroy di place where di pipol for still dey offa sakrifice and burn ofrin give juju.
2KI 14:5 Afta e don bi king, e kill di savant wey kill en papa.
2KI 14:6 But e nor kill di savant shidren. E obey God kommand, just as dem rite for Moses Law sey, “Make una nor kill papa, bikos of wetin dia pikin do and make una nor kill pikin, bikos of wetin dia papa do. If una must kill anybody, make e bi for en own sin.”
2KI 14:7 E win 10,000 Edom sojas for Salt Valley, katch Sela for war kon gi-am anoda name wey bi “Jokteel” and na dis name dem dey koll am kon rish today.
2KI 14:8 Dem send Amazaya go meet King Jehoash wey bi Jehoahaz pikin and Jehu grand-pikin for Israel sey, “Make yu kom make wi si face-to-face.”
2KI 14:9 King Jehoash ansa King Amazaya, “Lebanon bush send message to di cedar for Lebanon sey, ‘Make yu give yor dota to my son as en wife.’ Den one wiked animal for Lebanon kon skata di bush.
2KI 14:10 Yu distroy Edom pipol and e don dey make yor head big! Yu dey happy bikos yu win, but make yu stay for yor palis. Wetin make yu dey kause wahala for yorsef? Wetin make yu won distroy yorsef and Judah?”
2KI 14:11 But King Amazaya nor gri listin to am, so King Jehoash for Israel kon attack am. King Jehoash and Amazaya kon meet one-on-one for Bet-Shemesh wey dey Judah.
2KI 14:12 Israel pipol win Judah pipol and all of dem run go back to dia house.
2KI 14:13 Na Bet-Shemesh, Israel king, Jehoash for katch King Amazaya wey bi Jehoash pikin and Ahazaya grand-pikin. E attack Jerusalem kon break di wall from Efraim go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
2KI 14:14 All di gold, silva, di tins for God temple, di palis and evry oda tins wey dem seize from war, e kon karry dem go back to Samaria.
2KI 14:15 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get and en viktory ova King Amazaya for Judah, dem rite am for Israel kings history book.
2KI 14:16 Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with Israel kings for Samaria.
2KI 14:17 Joash pikin, King Amazaya for Judah, stay for anoda fifteen years afta, Jehoahaz pikin, King Jehoash for Israel don die.
2KI 14:18 Di rest tins wey Amazaya do, dem rite am for Judah kings history book.
2KI 14:19 Dem plan against am for Jerusalem, so e run go Lakish. But dem send some men go find and kill-am for der.
2KI 14:20 Dem karry en dead body put for horse kon beri am for Jerusalem with en grand-grand papa dem for David Town.
2KI 14:21 So Judah pipol take Zabud, Amazaya pikin wey bi sixteen years kon crown am as dia king.
2KI 14:22 Afta di king don die, Zabud kon ribuild Elat for Judah.
2KI 14:23 For di Fifteent year wen Joash pikin, King Amazaya dey rule Judah, Joash pikin, Jeroboam kon bi king for Israel and e rule from Samaria for forty-one years.
2KI 14:24 E nor gri obey God kommand; instead e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 14:25 E bring Israel borda kom back from Lebo-Hamat for nort go rish Arabah wotaside for sout, just as di Oga, Israel God tok thru Profet Jonah wey en papa bi Amittai, wey bi profet for Gat-Hefa.
2KI 14:26 God si as Israel pipol dey sofa; di sofa strong well-well, bikos nobody dey to help dem, weda slave or free man.
2KI 14:27 Bikos God nor won skata Israel pipol kom from di eart, E kon save dem thru Joash pikin, Jeroboam.
2KI 14:28 Di remainin tins wey Jeroboam do, plus all wetin e get and en viktory wey make Israel take-ova Damaskus and Hamat, dem rite all for Israel kings history book.
2KI 14:29 Jeroboam die and en pikin Zekaraya kon take-ova as king. Dem beri am with Israel kings for Samaria.
2KI 15:1 For twenty-seven years wen Jeroboam dey rule Israel, Amazaya pikin, Zabud kon bi king for Judah.
2KI 15:2 E bi sixteen years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-two years. En mama na Jekolaya wey kom from Jerusalem.
2KI 15:3 E do evritin wey God kommand am, just as en papa Amazaya obey God too.
2KI 15:4 But e nor skata di juju place, so dem still dey go offa sakrifice and burn incense for der.
2KI 15:5 God kon make di king sick. Di king get diziz for en skin until di day wey e die. Only en kon dey stay for one house, while en pikin Jotam dey kare, handle di palis and rule di pipol.
2KI 15:6 Di remainin tins wey Zabud do, plus all wetin e get, dem rite am for Judah kings history book.
2KI 15:7 Zabud die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Jotam kon take-ova as king.
2KI 15:8 For thirty-eight years wen King Zabud dey rule Judah, Jeroboam pikin, Zekaraya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for six mont.
2KI 15:9 E nor gri obey God, just as en grand-grand papa dem do. E kontinue to do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 15:10 Jabesh pikin, Shallum kon plan and kill-am for Ibleam, den take-ova as king.
2KI 15:11 Di remainin tins wey Zekaraya do, dem rite am for Israel kings history book.
2KI 15:12 Di way wey dem take kill-am kon make wetin God tok happen wen E tell Jehu sey, “Na four generashon for yor shidren go rule Israel.” And dat na wetin happen.
2KI 15:13 For thirty-nine years wey Uzzaya bi king for Judah, Jabesh pikin, Shallum kon bi king for Israel. E rule from Samaria for one mont.
2KI 15:14 Gadi pikin, Menahem kon from Tirzah go attack King Shallum for Samaria. E kill-am kon take-ova as king.
2KI 15:15 Di remainin tins wey Shallum do, plus all en plans, dem rite dem put for Israel kings history book.
2KI 15:16 For dat time, Menahem from Tirzah attack Tifsah. E kill evribody wey dey di town and doz wey dey stay near di town, bikos dem nor gri surenda. Even wimen wey get belle for der, e kut dia belle open.
2KI 15:17 For thirty-nine years wey Zabud bi king for Judah, Gadi pikin, Menahem kon bi king for Israel. E rule from Samaria for twelf years.
2KI 15:18 E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin. Wen e dey rule,
2KI 15:19 Assyria king, Pul kon attack di land and Menahem kon gi-am 1,000 silva, so dat di king go support and help am kontrol di kingdom.
2KI 15:20 Menahem kollect di silva from di rish pipol wey dey Israel. E take fifty-fifty silva from all of dem kon gi-am to Assyria king. Den Assyria king komot dia land and e nor kom back again.
2KI 15:21 Di remainin tins wey Menahem do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.
2KI 15:22 Menahem die and en pikin, Pekahaya kon take-ova as king.
2KI 15:23 For fifty years wen King Zabud dey rule for Judah, Menahem pikin, Pekahaya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for two years.
2KI 15:24 E nor gri obey God kommand; e kontinue to do like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 15:25 En offisa Pekah wey bi Remalaya pikin plan against am. En and fifty men from Gilead kon kill King Pekahaya, Argob and Arieh for Samaria. Dem kill dem for di place wey dem dey guide pass for di palis. Pekah kon take-ova as king.
2KI 15:26 Di remainin tins wey Pekahaya do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.
2KI 15:27 For fifty-two years wey King Zabud dey rule Judah, Remalaya pikin, Pekah kon bi king for Israel.
2KI 15:28 E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
2KI 15:29 Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
2KI 15:30 For twenty years wey Uzzaya pikin, Jotam don dey rule for Judah, Elah pikin, Hoshea kon plan and kill King Pekah wey Remalaya born, den e take-ova as king.
2KI 15:31 Di remainin tins wey Pekah do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.
2KI 15:32 For di sekond year wey Remalaya pikin, King Pekah dey rule Israel, Uzzaya pikin, Jotam kon bi king for Judah.
2KI 15:33 E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for sixteen years. En mama na Jerusha wey bi Zadok pikin.
2KI 15:34 Just like en papa Uzzaya, en too do as God kommand am.
2KI 15:35 But e nor skata di juju place, so di pipol still dey go der go offa sakrifice and burn incense. E build di Uppa Gate for God Temple.
2KI 15:36 Di remainin tins wey Jotam do, plus all wetin e get, dem rite dem put for Judah kings history book.
2KI 15:37 For dat time, God kon make King Rezin for Siria and Remalaya pikin, Pekah attack Judah.
2KI 15:38 Jotam die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Ahaz kon take-ova as king.
2KI 16:1 For seventeen years wey Remalaya pikin, Pekah dey rule, Jotam pikin, Ahaz kon bi king for Judah.
2KI 16:2 Ahaz na twenty years wen e stay to rule and e rule from Jerusalem for sixteen years. E nor gri obey God, just as en grand-grand papa David obey.
2KI 16:3 E dey do like odas wey rule Israel before am. E even burn en pikin as ofrin and dis na one bad sin wey di kountries wey God porshu komot for der, dey do.
2KI 16:4 Di king dey offa sakrifice and burn incense for juju altar, on-top hills and under evry green tree.
2KI 16:5 For dat time, King Rezin for Siria and Remalaya pikin, King Pekah for Israel kon attack Jerusalem. Dem fight King Ahaz, but dem nor fit konker am.
2KI 16:6 (Dat time King Rezin for Siria still attack Elat; e drive Judah pipol komot from der. Siria pipol kon go Elat and na dem dey stay der till today.)
2KI 16:7 King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.”
2KI 16:8 Den King Ahaz take silva and gold wey dey God Temple and di palis go give Assyria king.
2KI 16:9 Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.
2KI 16:10 Wen King Ahaz go Damaskus go meet King Tiglat-Pileser for Assyria, e kon si dia juju altar wey dey der. Den King Ahaz draw as di altar bi for paper kon send am go give Uriaya wey bi di priest.
2KI 16:11 Uriaya build one altar akordin to wetin dey di paper wey di king send kon gi-am from Damaskus.
2KI 16:12 Wen di king si di altar afta e don kom back from Damaskus, e kon go offa sakrifice for der.
2KI 16:13 E offa burnt sakrifice and korn ofrin. E pour en drink ofrin kon sprinkol blood for di altar as peace ofrin.
2KI 16:14 E take di bronze altar wey dey God present from di temple front (between di altar and God Temple) kon put am for di nort side for di new altar.
2KI 16:15 King Ahaz orda Uriaya kon tell am, “Make yu offa di morning sakrifice for di big altar, plus di evening ofrin, di royal burnt sakrifice, di food ofrin, di burnt sakrifice for Israel pipol, dia food sakrifice and evry oda sakrifice. Na only mi go dey use dis bronze altar.”
2KI 16:16 So Uriaya do as King Ahaz kommand am.
2KI 16:17 King Ahaz kut di stand komot kon remove di basin from dem. E take “Di Sea” from di bull wey dem make with bronze and wey dey support am kon put am for groun.
2KI 16:18 Di roof wey dem build for di temple and for di door-mot where di king dey pass enter inside for Sabat Day, e remove am too. E take dem komot, bikos e wont make Assyria king, happy.
2KI 16:19 Di remainin tins wey Ahaz do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book.
2KI 16:20 King Ahaz kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.
2KI 17:1 For twelf years wen King Ahaz dey rule Judah, Elah pikin, Hoshea kon bi king for Israel. E rule from Samaria for nine years.
2KI 17:2 E nor gri obey God, but en own nor bad rish di tins wey di oda kings wey dey before am, do.
2KI 17:3 King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.
2KI 17:4 Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.
2KI 17:5 Assyria king and en sojas mash go attack Samaria kon seize am for three years.
2KI 17:6 For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
2KI 17:7 Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga dia God; di Pesin wey save dem from Egypt pipol and King Fero hand. Dem dey woship oda gods;
2KI 17:8 di kountries wey God porshu bikos of Israel pipol, dem dey follow dem serve dia juju kon dey do all di bad-bad tins wey Israel kings do before.
2KI 17:9 Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well.
2KI 17:10 Dem build image and Asherah juju for evry high place and under evry green tree.
2KI 17:11 Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.
2KI 17:12 Even as God kommand dem rish, dem still dey woship dia yeye juju.
2KI 17:13 God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”
2KI 17:14 But una nor gri listin, instead una dey show strong head like dia grand-grand papa wey nor trust di Oga dia God.
2KI 17:15 Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.
2KI 17:16 Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
2KI 17:17 Dem offa dia shidren as sakrifice and dey do majik and oda bad-bad tins. Dem decide to dey do bad tins for God present and na dis make God dey vex.
2KI 17:18 So, bikos God dey vex for Israel pipol, E kon rijet dem; but Judah tribe still dey obey am.
2KI 17:19 Leta, Judah pipol nor gri obey wetin di Oga dia God tok; dem kon dey do like Israel pipol.
2KI 17:20 So God rijet all Jakob shidren-shidren; E disgrace and give dem to tif, until E komot all of dem from en present.
2KI 17:21 E remove Israel pipol from David generashon and Nebat pikin, Jeroboam kon bi dia king. Jeroboam drive Israel pipol komot from God present kon enkourage dem to sin well-well.
2KI 17:22 Israel pipol kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin and dem nor gri turn kom meet God.
2KI 17:23 So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.
2KI 17:24 Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.
2KI 17:25 Wen dem first rish der, dem nor gri woship God. So God kon send lion go meet and kill some of dem.
2KI 17:26 Dem kon tell Assyria king wetin happen sey, “Di pipol wey yu bring kom dis town, nor know wetin God wont for di town, so E don send lion kom kill dem. Di lion dey kill pipol, bikos dem nor know wetin God wont for di land.”
2KI 17:27 So Assyria king ansa, “Make una go bring one among di priest wey wi take from der kom. E go stay der kon tish us wetin God wont for di land.”
2KI 17:28 So di priest wey dem bin karry komot Samaria kon go back go stay for Bethel. E tish dem how to woship God.
2KI 17:29 But each tribe make dia own gods kon put dem for shrine for di high place wey Samaria pipol make. Each tribe do like dis for di town wey dem dey.
2KI 17:30 Di pipol wey kom from Babilon make Sukkot-Benot; while di ones wey kom from Kut, make Nergal and doz wey kom from Hamat, make Ashima;
2KI 17:31 di ones wey kom form Avva, make Nibhaz and Tartak; while doz wey kom form Sefarvaim dey burn dia sons for fire as sakrifice to Adrammelek and Anammelek wey bi Sefarvaim gods.
2KI 17:32 Bikos dem dey fear God well-well, dem kon pick some from dia own pipol wey go work as priest for di shrine wey dey di high place dem.
2KI 17:33 For di same time, dem dey woship God and serve dia gods, just as dem dey do from where dem from kom.
2KI 17:34 Till today, dem still dey woship dia gods. Dem stop to woship God or obey en rules, kommand and laws wey E give Jakob shidren-shidren.
2KI 17:35 God enter agriment with Israel pipol sey, “Una must nor woship anoda god. Make una nor bow, serve or offa sakrifice to dem.
2KI 17:36 Instead una must woship mi wey bring una kom out from Egypt with my great pawa. Una go bow and offa sakrifice to only mi.
2KI 17:37 Una must always dey obey my rules, laws and di kommandment wey I rite for una. Una must nor woship anoda god.
2KI 17:38 Una must nor forget di agriment wey I make with una and make una nor woship anoda god.
2KI 17:39 Make una woship di Oga wey bi una God; den E go save una from all una enemies.”
2KI 17:40 But dem nor listin; instead dem do as dem dey do before.
2KI 17:41 Even doh dis pipol dey woship God, dem still dey serve juju. So till today, dia shidren and shidren-shidren dey bihave like dem.
2KI 18:1 For di third year wen King Hoshea, Elah pikin dey rule for Israel, Ahaz pikin, Hezekaya kon bi king for Judah.
2KI 18:2 E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for twenty-nine years. En mama name na Abi wey bi Zekaraya pikin.
2KI 18:3 E obey God, just like en grand-grand papa David.
2KI 18:4 E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
2KI 18:5 E trust di Oga wey bi Israel God; so e nor get any king like am wey don rule Judah before or wey go rule Judah again.
2KI 18:6 E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.
2KI 18:7 God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem.
2KI 18:8 E win Filistia pipol for Gaza and di aria wey dey near der; rite from dia gate go rish di towns wey dem guide well-well for der.
2KI 18:9 For di fourt year wen King Hezekaya dey rule (dat na seven years wey Elah pikin, King Hoshea don dey rule for Israel), King Shalmanesa for Assyria go fight Samaria kon surround di town.
2KI 18:10 Afta three years, e kon seize Samaria (dat na di six years wey Hezekaya don dey rule) and na nine years wey King Hoshea don dey rule for Israel.
2KI 18:11 Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town.
2KI 18:12 Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.
2KI 18:13 For fourteen years wen King Hezekaya dey rule, King Sennakerib for Assyria attack all di towns wey dem guide well-well for Judah kon seize dem.
2KI 18:14 King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya.
2KI 18:15 King Hezekaya gi-am all di silva wey dey God Temple and for di palis.
2KI 18:16 For dat time, King Hezekaya for Judah, komot all di iron wey dem take make God Temple door kon give dem to Assyria king.
2KI 18:17 Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot.
2KI 18:18 Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.
2KI 18:19 Di shief adviser kon tell dem, “Make una tell Hezekaya sey: ‘Di great king for Assyria sey: Wetin dey give yu strong mind?
2KI 18:20 To dey boast sey yu don plan well to fight mi, nor mean anytin. Na who dey give yu mind sey yu fit fight mi?
2KI 18:21 Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am.
2KI 18:22 May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”
2KI 18:23 So, make yu follow my oga di king for Assyria enter agriment and e go give yu 2,000 horse as long as yu go fit find men wey go ride dem.
2KI 18:24 True-true, yu nor go sey no to even di smallest ofisas wey my masta get, bikos yu bilive sey Egypt pipol go kom help yu.
2KI 18:25 I wont make yu know sey na as God kommand, I go take mash kon distroy dis place, bikos God sey, “Make yu mash go distroy dis land.” ’ ”
2KI 18:26 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Joah kon ansa di adviser sey, “Make yu use Aramaik language take tok to yor savant, bikos wi undastand am. Nor tok to us with Hibru bikos of di pipol.”
2KI 18:27 But di shief adviser ansa, “My masta nor send mi sey make I kon tok dis message to only una and una oga. Dis message na for di pipol too wey sidan for di wall, bikos dem go chop dia own shit kon drink dia piss.”
2KI 18:28 Di shief adviser kon from der shaut with Hibru language, “Make una listin to di message wey di great king for Assyria sey make I tell una.
2KI 18:29 Dis na wetin di king tok: Make una nor let Hezekaya deceive una, bikos e nor go fit save una from my hand!
2KI 18:30 Make una nor let Hezekaya tell una sey, ‘Make una trust God, bikos E go save us; so Assyria king nor go fit do us anytin.’
2KI 18:31 “Make una nor listin to Hezekaya! Bikos Assyria king sey, ‘Make una rite leta kom sey una go respet am and do anytin wey e tok. Den each of una fit chop from di vine and fig kon drink wota from well,
2KI 18:32 until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’ “So make una nor listin to Hezekaya, bikos e dey deceive una wen e sey, ‘God go save us.’
2KI 18:33 E get any god for di oda kountry wey don save en pipol from Assyria king pawa?
2KI 18:34 Where di gods wey dey Hamat and Arpad? Where di gods wey dey Sefarvaim, Hena and Ivvah? True-true, una tink sey any god fit save Samaria from my pawa?
2KI 18:35 Among all di gods for di land, na wish one don fit save en pipol and land from my pawa? So how God won kon take save Jerusalem and en pipol from my hand?”
2KI 18:36 Di pipol kwayet and dem nor tok, bikos di king don tell dem sey, “Make nobody ansa.”
2KI 18:37 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Asaf pikin Joah kon tear dia klot go meet and tell Hezekaya wetin di shief adviser tok.
2KI 19:1 Wen King Hezekaya hear wetin dem tok, en too tear en klot kon wear sak go God Temple.
2KI 19:2 E send Eliakim, Shebna and di priest oga with di sak klot wey dem wear sey make dem go meet Profet Isaya, Amos pikin, sey:
2KI 19:3 “Dis na wetin Hezekaya tok: ‘Today na bad day, bikos na curse and trobol full am. E just bi like wen woman wey get belle won born, but e nor get pawa to push di pikin out.
2KI 19:4 May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”
2KI 19:5 Wen Isaya hear King Hezekaya message,
2KI 19:6 e kon sey, “Make una go tell di king sey: ‘God sey make yu nor let Assyria king treaten yu sey, en wey bi God nor go fit save yu.
2KI 19:7 God go put one kind spirit for inside am wey go make am hear rumor, den e go-go back to en own kountry, den God go kill-am for der.’ ”
2KI 19:8 Wen di shief adviser hear sey Assyria king don komot from Lakish go fight for Libnah; e kon go der go meet am.
2KI 19:9 Di king hear sey, King Tirhakah for Ethiopia dey mash kon fight am. E kon still send message go meet Hezekaya sey:
2KI 19:10 “Make una tell King Hezekaya for Judah sey: ‘Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.”
2KI 19:11 True-true yu don hear wetin Assyria king do to di oda lands. Yu tink sey God go save yu?
2KI 19:12 Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?
2KI 19:13 Where di kings for Hamat, Arpad, Lair, Sefarvaim, Hena and Ivvah?’ ”
2KI 19:14 Hezekaya take di leta from di messenja kon read am, den e go God Temple kon spread am on-top di altar.
2KI 19:15 Hezekaya pray to God kon sey: “Oga wey bi Israel God, na Yu bi king among di creatures wey get feadas! Na only Yu bi God ova all di kingdoms for dis eart. Na Yu make di sky and di eart.
2KI 19:16 My God, make Yu listin well-well! Make Yu open yor eye si tins for yorsef! Listin to di message wey Sennakerib send kom and as e curse Yu wey dey alive!
2KI 19:17 “My God, na true sey, Assyria king don distroy all di kountries and dia lands.
2KI 19:18 Dem don burn di gods for di oda kountries, bikos dem nor really bi god, bikos na human being make dem with dia hand from wood and stone. Dat na why Assyria king fit distroy dem.
2KI 19:19 Naw, my Oga God, make Yu save us with yor pawa, so dat all di kingdoms for dis eart go know sey na Yu bi Oga and di only God wey nor dey die.”
2KI 19:20 Amos pikin, Profet Isaya kon send message go meet King Hezekaya sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I don hear yor prayers about King Sennakerib for Assyria.
2KI 19:21 And dis na wetin I tok about am: “ ‘ “Zion dota wey neva sleep with anybody before, dey curse and laf yu; Jerusalem dota dey shake head follow yu.
2KI 19:22 Na who yu dey trobol and curse like dis? Na who yu dey shaut for and look with bad eye? Na di Holy One for Israel?
2KI 19:23 Yu send yor messenja make e kon boast for mi sey, yu use yor shariot and men take konker di highest mountin for Lebanon. Yu dey boast sey yu don kut di tall cedars and all di betta trees. And di part wey deep pass for di forest, yu boast sey yu don rish der.
2KI 19:24 Yu dey boast sey yu dig well kon drink wota from strenjas land and yor sojas use dia leg take dry River Nile for Egypt.
2KI 19:25 Dem nor tell yu sey na mi plan all dis tins before dem happen? I don do as I plan dem. Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well, to where dem dey trowey dirty put.
2KI 19:26 Di pipol wey dey for doz land nor get pawa and fear won kill dem trowey. Dem bi like grass wey dey field or plant wey dey grow on-top roof, but wen strong sun kom out, dem go die.
2KI 19:27 But I know evritin about yu; both di tins wey yu dey do and di place where yu dey go. I know how yu dey plan against mi.
2KI 19:28 I don hear evritin about yor plan for mi and yor pride. From naw go, I go put hook for yor nose kon klose yor mout, den take yu go back thru di same road wey yu take kom.” ’ ”
2KI 19:29 Den Isaya kon tell King Hezekaya, “Dis na sign of wetin go happen. “ ‘For dis year and next year, yu go chop only food wey just grow on en own, but as from di oda year, yu fit chop from di tins wey yu plant.
2KI 19:30 Doz wey remain for Judah go prosper like plant wey en rut enter groun kon dey produce betta fruit.
2KI 19:31 For Mount Zion and Jerusalem, pipol go dey save, bikos God sey dis tins must happen.’
2KI 19:32 “So dis na wetin God tok about Assyria king: “ ‘E nor go enter di town or shot one arrow against am. No soja go kom near di wall and nobody go build kamp near di town.
2KI 19:33 Assyria king go-go back as e take kom. E nor go enter dis town at-all.
2KI 19:34 Bikos of my own honor and di promise wey I make to my savant David, I go defend and protet dis town.’ ”
2KI 19:35 For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die.
2KI 19:36 So King Sennakerib for Assyria run komot from di kamp. E go en house kon stay for Nineveh.
2KI 19:37 One day as e dey woship en god for Nisrok temple, en sons, Adrammelek and Shareza kon kill-am with dia swod, den dem run go Ararat land. Sennakerib pikin, Esarhaddon kon take-ova as king.
2KI 20:1 For dat time, King Hezekaya kon dey sick and e nearly die. Amos pikin, Profet Isaya go si am kon sey, “God sey make yu arrange evritin as dem suppose dey, bikos yu nor go well again. Make yu ready to die.”
2KI 20:2 So Hezekaya turn face wall kon pray sey:
2KI 20:3 “My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.
2KI 20:4 Isaya waka leave di king, but before e pass di kourtyard centre for di palis, God kon tell am,
2KI 20:5 “Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.
2KI 20:6 I go let yu leave for anoda fifteen years. I go save yu and dis town, Jerusalem from Assyria king hand. Bikos of my honor and di promise wey I make with my savant David, I go defend dis town.’ ”
2KI 20:7 Den Isaya sey, “Make una skwiz some fig for mi.” So dem do as e orda dem and e put am for di king sore make en body for well.
2KI 20:8 King Hezekaya tell Isaya, “Wetin I go take know sey God go heal mi, so dat I go-go en Temple by dis time next tumoro?”
2KI 20:9 Isaya ansa, “Dis na di sign from God to show sey E go do wetin E tok. Yu go wont make di shadow for wall move go front ten times, abi make e go back ten times?”
2KI 20:10 Hezekaya ansa, “E dey eazy for di shadow to move go front, but e nor eazy to go back ten times.”
2KI 20:11 So, Profet Isaya pray to God and God make di shadow go back ten times for Ahaz wall.
2KI 20:12 For dat time, Baladan pikin, King Merodak-Baladan for Babilon send leta and gift go give King Hezekaya, bikos e hear sey Hezekaya dey sick.
2KI 20:13 King Hezekaya welkom di pipol wey dem send kom kon show dem evritin wey dey en palis, di silva, gold, spices and di betta olive oil, plus all di war tins and fine propaty. E nor get anytin for di palis and di whole kingdom wey King Hezekaya nor show dem.
2KI 20:14 Den Profet Isaya visit King Hezekaya kon ask, “Wetin dis men si? Where dem from kom?” Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon.”
2KI 20:15 Profet Isaya ask, “Na wetin dem don si for yor palis?” Hezekaya ansa, “Dem don si evritin for my palis. I show dem evritin wey wi get.”
2KI 20:16 Isaya kon tell King Hezekaya sey, “Make yu listin to God word,
2KI 20:17 ‘Si, evritin for yor palis, plus all di tins wey yor grand-grand papa dem don gada rish today, dem go pak all of dem one day karry go Babilon; nor-tin go remain.’ God still sey,
2KI 20:18 ‘Dem go karry some of yor own shidren go Babilon go bi priest for di king palis.’ ”
2KI 20:19 Hezekaya kon tell Isaya, “God word wey yu tok so, dey korrect.” Den e sey, “At least dis tins nor go happen for my own time.”
2KI 20:20 Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book.
2KI 20:21 Hezekaya kon die and en pikin Manasseh kon take-ova as king.
2KI 21:1 Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah.
2KI 21:2 E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.
2KI 21:3 E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.
2KI 21:4 E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.”
2KI 21:5 For di two kourtyard wey dey God Temple, e build altar for all di stars wey dey di sky.
2KI 21:6 E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
2KI 21:7 E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever.
2KI 21:8 I nor go porshu Israel pipol from dis land wey I don give to dia grand-grand papa, as long as dem obey all di kommand and laws wey I give dem thru Moses, my savant.”
2KI 21:9 But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.
2KI 21:10 So God kon tok thru en savant di profet sey:
2KI 21:11 “King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.
2KI 21:12 So dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok, ‘I go kause wahala for Jerusalem and Judah pipol. And e go shok anybody wey go hear wetin happen.
2KI 21:13 As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.
2KI 21:14 Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,
2KI 21:15 bikos dem don sin against mi kon make mi dey vex since wen dia grand-grand papa komot from Egypt kon rish naw!’ ”
2KI 21:16 Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
2KI 21:17 Di remainin tins wey Manasseh do, plus all wetin e get and di sins wey e kommit, dem rite dem put for Judah kings history book.
2KI 21:18 Manasseh die and dem beri am for Uzza gardin wey dey en palis and en pikin, Amon kon take-ova as king.
2KI 21:19 Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman.
2KI 21:20 E nor gri obey God kommand, but e sin like en papa Manasseh.
2KI 21:21 E dey do like en papa, bikos en too dey woship and bow to yeye gods and juju wey en papa woship.
2KI 21:22 E nor gri follow en grand-grand papa dem Oga wey bi God or listin to en kommand.
2KI 21:23 Amon savants kon plan and kill-am for en palis.
2KI 21:24 Di pipol for di land kon kill all doz wey plan kill King Amon, den dem kon make en pikin Josaya, king for Judah.
2KI 21:25 Di remainin tins wey Amon do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book.
2KI 21:26 Dem beri am for en own grave for Uzza gardin and en pikin Josaya kon take-ova as king.
2KI 22:1 Josaya na eight years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for thirty-one years. En mama name na Jedidah wey bi Adaya wey kom from Bozgat, pikin.
2KI 22:2 E do wetin God kommand kon dey work like David, en grand-grand papa. E nor do bad tins at-all.
2KI 22:3 For eighteen years wen King Josaya dey rule, di kourt seketry Shafan wey bi Azalaya pikin and Meshullam grand-pikin, go God Temple kon sey:
2KI 22:4 “Make yu go meet Hilkaya, di High Priest sey make e kount di money wey God pipol bring kom give di guards for di temple.
2KI 22:5 Tell dem make dem give and pay di men wey dey ripair God Temple,
2KI 22:6 with doz wey dey build and do oda tins. Make dem still buy wood and chisel stone wey dem go use take ripair am.
2KI 22:7 Nor sey make di men kon tell yu as dem take use di money, bikos dem use am well.”
2KI 22:8 Hilkaya wey bi di High Priest kon tell Shafan di kourt seketry sey, “I don si di Law Book for God Temple.” Hilkaya give di book to Shafan and e read am.
2KI 22:9 Shafan go meet di king kon tell am, “Yor savant don gada di money for di temple kon give di men wey won ripair di Temple.”
2KI 22:10 E still tell di king, “Priest Hilkaya give mi one book.” Den Shafan read di book for di king.
2KI 22:11 Wen di king hear di laws wey dey di book, e kon tear en klot.
2KI 22:12 Di king kon orda Priest Hilkaya, Shafan pikin Ahikam, Mikaya pikin Akbor, Shafan wey bi di kourt seketry and Asaya wey bi di king savant sey,
2KI 22:13 “Make una go meet and ask God for mi and Judah pipol. Make una find out wetin di words for di book mean. God don dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor gri obey wetin dey dis book at-all.”
2KI 22:14 So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.) Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom,
2KI 22:15 so di woman sey: “Make yu tell di man wey send yu kom meet mi sey, ‘God sey:
2KI 22:16 “I won kause wahala for dis place and for doz wey dey stay here. Wetin I go do, dey for di book wey Judah king don read.
2KI 22:17 Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’
2KI 22:18 Make una tell Judah king wey send una kom ask from God sey: ‘Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok about di word wey yu hear:
2KI 22:19 “Yu show sey yu dey sorry for di bad tins wey una do kon respet God wen yu hear how I won use dis place and di pipol wey dey stay here, as strong ezample for pipol wey dem curse.” ’ God sey, ‘Yu tear yor klot kon kry for my present and I don hear yu.
2KI 22:20 So I go let yu die first and dem go beri yu well.’ ” So, dem kon go tell di king evritin wey di profetes tok.
2KI 23:1 King Josaya gada all di leaders for Judah and Jerusalem togeda
2KI 23:2 kon go God Temple and all di pipol for Judah, doz for Jerusalem, di priests and di profets kon follow am. All di pipol dey der, both small pikin, yong men and old pipol. E read di kovenant wey dey di book wey dem si for di temple.
2KI 23:3 Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
2KI 23:4 Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
2KI 23:5 E kill all di priest wey nor know God wey Judah kings bin choose sey na dem go dey offa sakrifice for di high place for di towns for Judah and di arias around Jerusalem. (Dem dey offa sakrifice to Baal, di sun and moon; to di planets and all di stars for di sky.)
2KI 23:6 E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.
2KI 23:7 Di men ashawo house wey dey di temple and di place where wimen for dey weave for Asherah juju, e distroy dem.
2KI 23:8 E bring all di priests from Judah kon skata di high place where dem for dey offa sakrifice from Gibeah go rish Beersheba. E skata di high place dem for di goat juju wey dey di door-mot for Joshua gate wey bi di main town wey dey di left side.
2KI 23:9 (For dis time, di priests for di high place dem nor go God altar for Jerusalem go serve am, but dem follow di oda priests chop from di bread wey nor get yist).
2KI 23:10 Di king skata Tofet for Ben-Hinnom Valley, so dat nobody go fit sakrifice en pikin for Molek juju again.
2KI 23:11 All di horse image wey di kings for Judah put for di temple gate to take woship di sun, di king skata all of dem. (Dem keep dem near Natan Melek; di lawyer room wey dey near di kourtyard.) Di king burn all di shariot wey dem take dey woship di sun.
2KI 23:12 Di altars wey Judah kings build for Ahaz room for up, plus di one wey Manasseh build for di two kourtyard for God Temple, di king burn all of dem kon trow dia ashes for Kidron Valley.
2KI 23:13 Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.
2KI 23:14 E skata dia juju pila finish kon kut Asherah juju pole rish groun, den e pak human being bones full di shrine.
2KI 23:15 E still skata di altar for Bethel and na Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin, build am. Den e burn all di high place to ashes kon distroy Asherah juju.
2KI 23:16 As King Josaya turn, e kon si di grave for di mountin, so e sey make dem bring di bones kom out. E burn dem for di altar kon skata di ashes. Dis tin happen, just as God tok thru en profet for di time wey King Jeroboam stand for di altar, wen dem dey do one feast. King Josaya turn kon si di grave of di profet wey tok dis tins.
2KI 23:17 E kon ask, “Wetin bi dis sign wey I dey si so?” Di men from di town kon ansa, “Di profet wey kom from Bethel kon tok about dis tin wey yu don do to Jeroboam grave and Bethel altar, na en grave bi dis.”
2KI 23:18 Di king kon sey, “Make una nor skata or tosh en grave! Make nobody disturb am at-all.” So dem leave di profet grave, plus all di oda profets for Israel wey dem beri for der.
2KI 23:19 King Josaya still distroy all di shrine for di high place for Samaria town. Na Israel kings build dem and dem dey make God vex. As e take distroy di altar for Bethel, na so too e distroy all dis ones.
2KI 23:20 All di priests for di high place, e sakrifice dem for di altars wey dey der kon burn human being bones for der. Den e go back to Jerusalem.
2KI 23:21 Di king kommand di pipol, “Make una dey obey di Oga una God Passova, just as E dey dis kovenant book.”
2KI 23:22 E tok like dis bikos, dem neva celebrate Passova afta di time wey judge rule di kountry. Since dat time, no king for Israel or Judah don celebrate am.
2KI 23:23 But for eighteen years wen King Josaya dey rule, dem kon celebrate God Passova for Jerusalem.
2KI 23:24 King Josaya still distroy all di pit from where dem for dey koll evil spirit kom out. Di pipol wey dey do majik; dia juju for house; di yeye image and all di juju wey dey for Judah and Jerusalem land, e distroy dem too. Like dis, e kon do all di tins wey dem rite for di book wey Priest Hilkaya si for di temple.
2KI 23:25 E nor get any king before or afta wey turn kom meet God like King Josaya wey use en whole heart take serve God, just as Moses Law tok.
2KI 23:26 Plus all dis ones, God still dey vex for Judah, bikos of all di wiked tins wey Manasseh do.
2KI 23:27 God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”
2KI 23:28 Di remainin tins wey Josaya do plus evritin wey e get, dem rite am put for Judah kings history book.
2KI 23:29 Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.
2KI 23:30 King Josaya savant karry en oga dead body from Megiddo on-top horse go back to Jerusalem for where dem for beri am for en grave. Di pipol for di land take Josaya pikin, Jehoahaz, pour olive oil for en head kon make am king for Judah.
2KI 23:31 Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin.
2KI 23:32 E nor gri follow God kommand, just like en grand-grand papa dem.
2KI 23:33 Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.
2KI 23:34 Fero Neko make Josaya pikin Eliakim king kon shange en name to Jehoiakim. E take Jehoahaz go Egypt where e for die.
2KI 23:35 Jehoiakim dey give Fero di normal amount wey e sey make dem dey gi-am. But to make sure sey e meet dis payment, e kon dey tax di pipol for di land. E dey kollect plenty money from each pesin, so dat e go fit pay Fero Neko.
2KI 23:36 Jehoiakim na twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama na Zebidah wey bi Pedaaya from Rumah pikin.
2KI 23:37 E nor gri obey God, just like en grand-grand papa dem.
2KI 24:1 Wen Jehoiakim dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack dem. Jehoiakim obey King Nebukadnezzar for three years, den e kon won fight against am.
2KI 24:2 God kon send Babilon, Siria, Moab and Ammon sojas against am; God send dem go distroy Judah, as E bin warn dem thru en profets.
2KI 24:3 Just as God don tok before, E rijet Judah and en pipol, bikos of all di sins wey Manasseh kommit.
2KI 24:4 Manasseh kill pipol wey nor do anytin and dia blood don stain Jerusalem, so God nor gri forgive dem.
2KI 24:5 Di remainin tins wey Jehoiakim do plus evritin wey e get, dem rite am put for Judah kings history book.
2KI 24:6 E die and en pikin, Jehoiashin kon take-ova as king.
2KI 24:7 Egypt king with en men nor komot from dia land again go fight, bikos Babilon king don konker evriwhere wey Egypt king bin get before from Egypt wotaside go rish Eufrates River.
2KI 24:8 Jehoiashin na eighteen year wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama na Nehushta and na Elnatan wey kom from Jerusalem, born am.
2KI 24:9 E nor gri obey God, just like en grand-grand papa dem.
2KI 24:10 For dat time, di offisa oga for King Nebukadnezzar for Babilon kon go fight and seize Jerusalem.
2KI 24:11 King Nebukadnezzar for Babilon kom di town wey en offisa seize.
2KI 24:12 King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.
2KI 24:13 All di good and betta tins wey dey di royal palis and di temple, King Nebukadnezzar pak all of dem. All di gold tins wey King Solomon for Israel make put for God Temple, King Nebukadnezzar remove all of dem, just as God tok.
2KI 24:14 King Nebukadnezzar karry evribody komot from Jerusalem, plus di ofisas and sojas (all di pipol, na 10,000). Plus all di men wey get skill and doz wey dey work with iron. E nor leave anybody esept di poor pipol wey dey di land.
2KI 24:15 E karry King Jehoiashin from Jerusalem go Babilon, with di king mama, en wifes, priests and all di top ofisas for di land.
2KI 24:16 King Nebukadnezzar karry all di sojas 7,000, plus 1,000 men wey dey work. All doz wey get heart and sabi fight dey join dem too.
2KI 24:17 King Nebukadnezzar kon make Jehoiashin papa broda, Matanaya king for Jehoiashin place. E shange Matanaya name to Zedekaya.
2KI 24:18 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey kom form Libnah, born am.
2KI 24:19 E nor gri obey God, just as Jehoiakim bin do.
2KI 24:20 So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.
2KI 25:1 For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.
2KI 25:2 En and en men dey der for two years and dat na di elevent year wen King Zedekaya dey rule.
2KI 25:3 For di ninet day for di fourt mont for di same year wen honga for di town don strong well-well and all dia food don finish,
2KI 25:4 di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.
2KI 25:5 But Babilon sojas porshu di king, katch am for Jeriko field and all en sojas run leave am.
2KI 25:6 Dem katch di king kon karry am go meet King Nebukadnezzar for Riblah, where e for judge en matter.
2KI 25:7 Dem kill all Zedekaya sons for Zedekaya present. So Babilon king sey make dem pul Zedekaya eyes komot kon shain am with bronze shain, den karry am go Babilon.
2KI 25:8 For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.
2KI 25:9 E burn God Temple, di royal palis and all di house for Jerusalem.
2KI 25:10 Babilon sojas wey kom with di soja oga kon distroy all di wall for Jerusalem.
2KI 25:11 Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.
2KI 25:12 But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.
2KI 25:13 Babilon sojas break di two bronze pila wey dey God Temple, plus di stand wey dem dey move and di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” Dem karry di bronze dem go Babilon.
2KI 25:14 Dem still karry di pots, shovels, trimmin shear, pans and all di tins wey dem make with bronze wey di priest dey use.
2KI 25:15 Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.
2KI 25:16 Di bronze tins wey King Solomon make for God Temple, plus di two pila, di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea,” di twelf bronze bull under “Di Sea” and di stand wey dem dey move, dey too heavy to karry.
2KI 25:17 Each of di pilas high rish twenty-seven fit. Di bronze top for one pila high rish four and half fit and dem dekorate di bronze with pomegranate fruit. Na so too dem dekorate di sekond pila.
2KI 25:18 Nebuzaradan katch Priest Seraya, Zefanaya di sekond priest and di three pipol wey dey guide di gate, den e karry dem go as prisonas.
2KI 25:19 From di town, e still take one among di sojas offisa, five pipol from di king adviser wey dem si for di town, one seketry among di sojas wey dey train pipol as sojas and sixty pipol from di land wey dem seize.
2KI 25:20 Nebuzaradan karry dem go meet King Nebukadnezzar for Riblah.
2KI 25:21 King Nebukadnezzar sey make dem kill all of dem for Riblah wey dey near Hamat. Na so dem take karry Judah pipol komot from dia land.
2KI 25:22 Naw, King Nebukadnezzar for Babilon kon make Gedalaya wey bi Ahikam pikin and Shafan grand-pikin, govnor ova Judah pipol wey dey en land.
2KI 25:23 All di offisa for Judah sojas and dia men hear sey Babilon king don make Gedalaya govnor for Judah. So dem kon go meet Gedalaya for Mizpa. Di ofisas wey kom na, Netanaya pikin, Ishmael; Kareah pikin, Johanan; Tanhumet pikin, Seraya and Maakat pikin, Jaazanaya.
2KI 25:24 Gedalaya kon promise sey e go save dem and dia men. E sey, “Make una nor fear to work with Babilon sojas. Make una stay for di land kon surenda to King Nebukadnezzar, den evritin go dey well.”
2KI 25:25 But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
2KI 25:26 Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.
2KI 25:27 For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.
2KI 25:28 E sorry and trit King Jehoiashin well kon gi-am house wey betta pass where all di oda kings for Babilon dey stay.
2KI 25:29 E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol,
2KI 25:30 so King Evil-Merodak dey give Jehoiashin evritin wey e wont until Jehoiashin die.
1CH 1:1 Na Adam born Seth, Seth born Enosh, Enosh born Kenan
1CH 1:2 and na Kenan born Mahalalel. Na Mahalalel bi Jared papa.
1CH 1:3 Jared born Enoch, Enoch born Metuselah, Metuselah kon born Lamek.
1CH 1:4 Lamek born Noah, Noah born Shem, Shem born Ham and na Ham born Jafet.
1CH 1:5 Jafet shidren na: Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.
1CH 1:6 Gomer shidren na: Ashkenaz, Difat and Togarmah.
1CH 1:7 Javan shidren na: Elisha, Tarshish, Kittite and Rodan.
1CH 1:8 Ham shidren na: Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
1CH 1:9 Kush shidren na: Seba, Havilah, Sabteka, Rama and Sabtah. Rama shidren na: Sheba and Dedan.
1CH 1:10 Na Kush born Nimrod and Nimrod kon bi di first pesin wey strong well-well for di world.
1CH 1:11 Na Mizraim born Lud, Anam, Lehab, Naftuh,
1CH 1:12 Patrus, Kasluh, Krete (wey Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol too.
1CH 1:13 Na Kanaan bi Sidon and Het papa, but na Sidon bi en first pikin.
1CH 1:14 Na Kanaan still born Jebus, Amor, Girgash,
1CH 1:15 Hiv, Ark, Sin,
1CH 1:16 Arvad, Zemar and Hamat pipol.
1CH 1:17 Shem shidren na: Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Aram. Aram shidren-shidren na: Uz, Hul, Geta and Meshak.
1CH 1:18 Na Arfaxad born Shelah and na Shelah bi Eber papa.
1CH 1:19 Eber born two pikin: one name na Peleg (wey mean divide), bikos e born am for di time wen God take divide and make pipol dey speak difren language for di world. Di oda pikin name na Joktan.
1CH 1:20 Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,
1CH 1:21 Hadoram, Uzal, Diklah,
1CH 1:22 Ebal, Abimael, Sheba,
1CH 1:23 Ofir, Havilah and Jobab pipol.
1CH 1:24 Na Shem and Abram family pipol bi dis: Shem, Arfaxad, Shelah,
1CH 1:25 Eber, Peleg, Reu,
1CH 1:26 Serug, Nahor, Terah
1CH 1:27 and Abram wey God shange en name to Abraham.
1CH 1:28 Abraham born two sons: Isaak and Ishmael.
1CH 1:29 Dis na dia shidren-shidren: Na Nebaiot bi Ishmael first pikin, before e kon born Kedar, Adbeel, Mibsam,
1CH 1:30 Mishma, Dumah, Massa, Hadad, Tema,
1CH 1:31 Jetur, Nafish and Kedemah. Na Ishmael shidren dem bi.
1CH 1:32 Keturah wey bi Abraham girl-friend, na-im born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah. Na Jokshan born Sheba and Dedan.
1CH 1:33 Midian shidren na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis pipol na Keturah sons.
1CH 1:34 Na Abraham bi Isaak papa. Isaak shidren na: Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel).
1CH 1:35 Esau shidren na: Elifaz, Reuel, Jeush, Jalam and Korah.
1CH 1:36 Elifaz shidren na: Teman, Omar, Zefi, Gatam, Kenaz, but Timna still born Amalek for am.
1CH 1:37 Reuel shidren na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah.
1CH 1:38 Seir shidren na: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, Dishon, Ezer and Dishan.
1CH 1:39 Lotan shidren na: Hori and Homam (and Timna, na Lotan sista).
1CH 1:40 Shobal shidren na: Alvan, Manahat, Ebal, Shefi and Onam. Zibeon shidren na: Aiaya and Anah.
1CH 1:41 Anah son na Dishon. Na Dishon born Hamran, Eshban, Itran and Keran.
1CH 1:42 Ezer shidren na: Bilhan, Zaavan, Jaakan. Na Dishan born Uz and Aran.
1CH 1:43 Na di kings wey rule Edom land before any king rule Israel pipol bi dis. Bela wey Beor born and e kom from Dinhabah.
1CH 1:44 Wen Bela die, Jobab wey bi Zera pikin wey kom from Bozrah kon take-ova as king.
1CH 1:45 Wen Jobad die, Husham wey kom from Teman land kon take-ova as king.
1CH 1:46 Wen Husham die, Hadad wey Bedad born kon take-ova as king and e rule from Avit town. E win Midian pipol for war for Moab.
1CH 1:47 Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon take-ova as king.
1CH 1:48 Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon take-ova as king.
1CH 1:49 Wen Shaul die, Baal-Hanan wey Akbor born kon take-ova as king.
1CH 1:50 Wen Baal-Hanan die, Hadad wey kom from Pau kon take-ova as king. En wife name na Mehetabel, wey bi Matred pikin and na Me-Zahab bi Matred mama.
1CH 1:51 Hadad kon die. Di shief for Edom tribe na: Timna, Alvah, Jetet,
1CH 1:52 Oholibama, Elah, Pinon,
1CH 1:53 Kenaz, Teman and Mibzar,
1CH 1:54 Magdiel and Iram. All dis na dis na Edom shiefs.
1CH 2:1 Israel sons na: Reuben, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Zebulun,
1CH 2:2 Dan, Josef, Benjamin, Naftali Gad and Asher.
1CH 2:3 Judah sons na: Er, Onan and Shelah. Na one Kanaan woman wey en name na Batshua, born dis three shidren for Judah. Er wey bi Judah first pikin kon make God vex and God kill-am.
1CH 2:4 Tamar wey bi Judah pikin wife, born Perez and Zera give Judah and all en sons kon bi five.
1CH 2:5 Perez sons na: Hezron and Hamul.
1CH 2:6 Zera sons na: Zimri, Etan, Heman, Kalkol and Dara.
1CH 2:7 Karmi sons na: Akan wey bring wahala kom Israel wen e tif wetin dem dedikate give God.
1CH 2:8 Na Etan born Zabud.
1CH 2:9 Di sons wey dem born give Hezron na: Jerahmeel, Ram and Kaleb.
1CH 2:10 Na Ram bi Amminadab papa and Amminadab born Nahshon wey bi shief for Judah tribe.
1CH 2:11 Nahshon born Salma and na Salma born Boaz.
1CH 2:12 Boaz na Oded papa and na Obed born Jesse.
1CH 2:13 Eliab na Jesse first pikin, why Abinadab na di sekond born, follow by Shimea,
1CH 2:14 before Netanel, Raddai,
1CH 2:15 Ozem and David.
1CH 2:16 Dia sistas na Zeruaya and Abigail. Zeruaya three sons na: Abishai, Joab and Asahel.
1CH 2:17 Abigail born Amasa wey en papa kom from Ishmael tribe.
1CH 2:18 Kaleb wey bi Hezron pikin marry Azuba wey dem still dey koll Jeriot. En sons na: Jesher, Shobab and Ardon.
1CH 2:19 Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am.
1CH 2:20 Na Hur bi Uri papa and na Uri born Bezalel.
1CH 2:21 Wen Hezron don rish sixty years, e kon marry Gilead sista wey Makir bi dia papa and e born Segub for am.
1CH 2:22 Na Segub bi Jair papa, wey get twenty three towns for Ramot land.
1CH 2:23 But Geshur and Aram win Jair, Kenat and sixty towns for der. All dis shidren na Makir wey bi Gilead papa grand-grand shidren.
1CH 2:24 Afta Hezron don die, Kaleb kon sleep with Efrat wey bi en papa wife and e born Ashhur wey bi Tekoa papa.
1CH 2:25 Jerahmeel wey bi Hezron first son, en shidren na: Ram, Bunah, Oren, Ozem and Ahijah.
1CH 2:26 Jerahmeel get anoda wife wey dem dey koll Atarah and na en bi Onam mama.
1CH 2:27 Ram wey bi Jerahmeel first son, en shidren na: Maaz, Jamin and Eker.
1CH 2:28 Onam sons na: Shammai and Jada. Shammai sons na Nadab and Abishur.
1CH 2:29 Na Abihail bi Abishur wife and e born Ahban and Molid for am.
1CH 2:30 Nadab sons na: Seled and Appaim. Seled nor born boy pikin before e die.
1CH 2:31 Appaim son na: Ishi and Ishi born Sheshan, while Sheshan born Ahlai.
1CH 2:32 Jeda wey bi Shammai broda, en sons na: Jeta and Jonatan. Jeter nor born boy pikin before e die.
1CH 2:33 Jonatan sons na: Pelet and Zaza. Na Jerahmeel shidren-shidren dem bi.
1CH 2:34 Sheshan born only girls. Sheshan get one Egypt pesin wey bi en savant and en name na Jarha.
1CH 2:35 Sheshan give en girl pikin to en savant as wife and e kon born Attai for am.
1CH 2:36 Na Attai bi Natan papa, while Natan kon bi Zabad papa.
1CH 2:37 Na Zabad bi Eflal papa, while Eflal born Obed.
1CH 2:38 Obed na Jehu papa and Jehu na Zabud papa.
1CH 2:39 Na Zabud bi Helez papa and Helez na Eleasah papa.
1CH 2:40 Eleasah born Sismai and na Sismai bi Shallum papa.
1CH 2:41 Jekamaya wey born Elishama, na Shallum bi en papa.
1CH 2:42 Kaleb wey bi Jerahmeel broda, en sons na: Mesha wey bi Zif papa and en sekond pikin na Maresha wey bi Hebron papa.
1CH 2:43 Hebron sons na: Korah, Tappuah, Rekem and Shema.
1CH 2:44 Shema na Raham and Jorkeam papa. Rekem na Shammai papa.
1CH 2:45 Shammai son na Maon wey bi Bet-Zur.
1CH 2:46 Kaleb girl-friend wey dem dey koll Efah kon born Haran, Moza and Gazez. Na Haran bi Gazez papa.
1CH 2:47 Jahdai sons na: Regem, Jotam, Geshan, Pelet, Efah and Shaaf.
1CH 2:48 Kaleb girl-friend wey bi Maaka born Sheba and Tirhana.
1CH 2:49 Na Maaka still born Shaaf wey bi Madmanna, Sheva, Makbena and Gibea papa. Kaleb girl pikin na, Aksah.
1CH 2:50 All dis na Kaleb shidren-shidren. Hur wey bi Efrat first pikin, na en sons bi dis: Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa;
1CH 2:51 Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.
1CH 2:52 Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa, en sons na: Haroeh and half of Manahat pipol.
1CH 2:53 Kiriat-Jearim family na: Itrite, Put, Shumat and Mishra pipol. Pipol for Zorat and Eshtaol kom from dis group.
1CH 2:54 Salma sons na: Betlehem, Netofat, Atrot Bet-Joab, half of Manahat and Zor pipol,
1CH 2:55 while di skribe pipol wey dey stay for Jabez na: Tirat, Shimeat and Sukat. Dis na Ken pipol wey kom from Hamat, wey bi Rekab papa.
1CH 3:1 Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.
1CH 3:2 Di third one na Absalom, en mama name na Maaka and na Talmai wey bi Geshur king, born am; di next one na Adonijah and na Haggit bi en mama;
1CH 3:3 Shefataya na di fift one and en mama name na Abital; Itream wey en mama name na Eglah, na-im bi di sixt one.
1CH 3:4 Dis na di six shidren wey dem born give David for Hebron where e for rule for seven years and six monts. E rule Jerusalem for thirty-three years:
1CH 3:5 Shimea, Shobab, Natan and Solomon na di sons wey dem born give David for Jerusalem and na Batsheba wey bi Ammiel pikin, bi dia mama.
1CH 3:6 David oda nine shidren na: Ibhar, Elishua, Elifelet,
1CH 3:7 Nogah, Nefeg, Jafia,
1CH 3:8 Elishama, Eliada and Elifelet.
1CH 3:9 Na David sons bi dis, dem nor kount di sons wey en girl-friends born for am. Tamar na dia sista.
1CH 3:10 Solomon born Rehoboam, Rehoboam born Abijah, Abijah born Asa wey born Jehoshafat,
1CH 3:11 Jehoshafat born Joram, Joram born Ahazaya and Ahazaya born Joash.
1CH 3:12 Joash born Amazaya wey born Zabud; Zabud born Jotam and Jotam kon born Ahaz.
1CH 3:13 Ahaz born Hezekaya; na Hezekaya born Manasseh and na Manasseh bi Amnon papa.
1CH 3:14 Amon na Josaya papa.
1CH 3:15 Josaya sons na: Johanan, Jehoiakim, Zedekaya and Shallum.
1CH 3:16 Jehoiakim sons na: Jehoiashin and Zedekaya.
1CH 3:17 Jehoiashin sons wey Babilon pipol karry go prison na: Shealtiel,
1CH 3:18 Malkiram, Pedaaya, Shenazzar, Jekamaya, Hoshama and Nedabaya.
1CH 3:19 Pedaaya shidren-shidren na: Zerubabel and Shimei. Na Meshullam and Hananaya bi Zerubabel shidren and na Shelomit bi dia sista.
1CH 3:20 Zerubabel oda five shidren na: Hashubah, Ohel, Berakaya, Hasadaya and Jushab-Hesed.
1CH 3:21 Hananaya shidren-shidren na: Pelataya and Jeshaya. Jeshaya born Refaaya wey bi Arnan papa and na Arnan born Obadaya wey bi Shekanaya papa.
1CH 3:22 Shekanaya born only Shemaya and Shemaya sons na: Hattush, Igal, Baraya, Nearaya and Shafat. All of dem na six.
1CH 3:23 Nearaya three sons na: Elioenai, Hezekaya and Azrikam.
1CH 3:24 Elioenai get seven sons and dem bi: Hodevah, Eliashib, Pelaaya, Akkub, Johanan, Delaaya and Anani.
1CH 4:1 Judah shidren-shidren na: Perez, Hezron, Karmi, Hur and Shobal.
1CH 4:2 Na Shobal bi Reaaya papa; Reaaya na Jahat papa; Jahat kon bi Ahumai and Lahad papa and na dem bi Zorah pipol grand-grand papa.
1CH 4:3 Etam sons na: Jezrel, Ishma and Idbash. Dia sista name na Hazelelponi.
1CH 4:4 Na Penuel bi Gedor papa, while Ezer kon bi Hushah papa. Hur wey bi Efrat first pikin and Betlehem pipol papa, na en shidren-shidren bi dis.
1CH 4:5 Ashhur wey bi Tekoa papa marry two wifes; Helah and Naarah.
1CH 4:6 Naarah born Ahuzzam, Hefa, Temeni and Haahashtari.
1CH 4:7 Helah sef born: Zeret, Zohar, Etnan
1CH 4:8 and Koz wey kon bi papa to Anub, Hazzobebah and Aharhel pipol wey Harum born.
1CH 4:9 E get one man wey dem dey respet well-well among en brodas and en name na Jabez. En mama koll am Jabez (wey mean pain) bikos e sey, “I sofa well-well wen I won born yu.”
1CH 4:10 Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.
1CH 4:11 Kelub wey bi Shuha broda, na-im bi Mehir papa and na Mehir born Eshton.
1CH 4:12 Na Eshton born Bet-Rafa, Paseah and Tehinnah wey bi Ir Nahash papa. All of dem na Rekah men.
1CH 4:13 Kenaz born Otniel and Seraya; Otniel born Hatat and Meonotai.
1CH 4:14 Na Meonotai bi Ofrah papa and na Seraya born Joab. Na dis Joab born doz pipol wey dey stay and karve wood for Ge-Harashim.
1CH 4:15 Kaleb wey Jefunneh born, en sons na: Iru, Elah and Naam. Na Elah bi Kenaz papa.
1CH 4:16 Jehallelel sons na: Zif, Zifah, Tiria and Asarel.
1CH 4:17 Ezra sons na: Jeta, Mered, Efer and Jalon. Na Eshtemoa wey bi Mered wife born Miriam, Shammai and Ishbah wey bi Eshtemoa papa.
1CH 4:18 Mered still marry one woman wey kom from Judah tribe and dem born three sons: Jared wey build Gedor town: Heba wey build Soko town and Jekutiel wey build Zanoah town.
1CH 4:19 Hodaya marry Naham sista. Na one among di woman son bi papa to Keilah wey kom from Garm and Eshtemoa wey kom from Maakat.
1CH 4:20 Shimon four shidren na: Amnon, Rinnah, Ben-Hanan and Tilon. Ishi shidren-shidren na: Zohet and Ben Zohet.
1CH 4:21 Shelah na one among Judah sons and na-im born Er wey Leka papa; Laada wey bi Maresha papa from Bet-Ashbea town where dem for dey make linen;
1CH 4:22 Jokim and all di pipol wey dey stay for Kozeba town. E still born Joash and Saraf wey rule for Moab and Jashubi Lehem. (All dis names na from di old rekord book).
1CH 4:23 Na dem bi di potta wey stay for Netaim and Gederah dey work for di king.
1CH 4:24 Simeon shidren-shidren na: Nemuel, Jamin, Jarib, Zera and Shaul.
1CH 4:25 Shaul sons na: Shallum, Mibsam and Mishma.
1CH 4:26 Mishma sons na: Hammuel, Zakkur and Shimei.
1CH 4:27 Shimei get sixteen sons and six dotas. But en brodas nor born many shidren, so dia family nor many rish Judah sons.
1CH 4:28 Simeon shidren-shidren stay for Beersheba, Moladah, Hazar-Shual,
1CH 4:29 Bilhah, Ezem, Tolad,
1CH 4:30 Betuel, Hormah, Ziklag,
1CH 4:31 Bet-Marcabot, Hazar-Susim, Bet-Biri and Shaaraim. Dis na dia towns till David kon bi king.
1CH 4:32 Dem still stay for Etam, Ain, Rimmon, Token and five towns for Ashan.
1CH 4:33 Dem still stay for all di small-small village wey dey near dis towns go rish Baal. Na where dem stay bi dat and dem rite and keep all dia family history.
1CH 4:34 Dia family leaders na: Meshobab, Jamlek, Joshah wey bi Amazaya pikin,
1CH 4:35 Joel, Jehu wey bi Joshibaya pikin and na Seraya wey Asiel born bi en grand-papa.
1CH 4:36 E still get Elioenai, Jaakobah, Jeshohaya, Asaya, Adiel, Jesimiel, Benaya,
1CH 4:37 Ziza wey bi Shipi pikin. Na Allon wey Jedaya born, bi Shipi papa. Shimri born Jedaya and na Shemaya bi Shimri papa.
1CH 4:38 Na dis pipol bi di leaders for dia family. Dia family kon dey many more-more.
1CH 4:39 Dem go where dem dey take enter Gedor kon even waka rish di east side for di valley, dey find grass make dia animals chop.
1CH 4:40 Dem si betta big land, where nobody go for disturb dem, den dem kon give dia sheep grass chop. Some pipol from Ham don dey stay der before dat time.
1CH 4:41 Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop.
1CH 4:42 Pelataya, Nearaya, Refaaya and Uzziel wey bi Ishi pikin, na dem lead Simeon five hundred men go di hill kountry for Seir,
1CH 4:43 where dem for kill Amalek pipol wey run go stay der and dem dey stay der kon rish today.
1CH 5:1 Reuben wey bi Jakob first pikin, na en shidren-shidren bi dis. But bikos e sleep with en papa wife, di papa kon give en senior pozishon to Josef. So for dia family history, dem nor rite Reuben as di first-born.
1CH 5:2 Bikos na Judah strong pass, dem kon make am leader among en brodas, but na Josef dem still take as first pikin.
1CH 5:3 Reuben wey bi Jakob first pikin, en four sons na: Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
1CH 5:4 Joel shidren-shidren na: Shemaya, Gog, Shimei,
1CH 5:5 Mikah, Reaaya, Baal and
1CH 5:6 Beerah wey bi leader for Reuben tribe wey Tilgat-Pilneser, Assyria king karry go anoda land.
1CH 5:7 Dis na di names wey dem rite for di family: Jeiel, Zekaraya
1CH 5:8 and Bela wey Azaz born and na Shema wey kom from Joel tribe, bi en grand-papa. Dis tribe dey stay for Aroer go rish Nebo and Baal-Meon.
1CH 5:9 Bikos dem get many animals for Gilead land, dem kon spread face east for di wildaness side go rish Eufrates River.
1CH 5:10 For di time wen Saul bi king, Reuben tribe attack and kill Hagrit pipol for war, den dem take dia land for di east side for Gilead.
1CH 5:11 Gad tribe stay from Bashan land near Reuben tribe land go rish Salekah wey dey di east.
1CH 5:12 Na Joel dey lead dem, sekond to Shafam, before Janai and Shafat.
1CH 5:13 Di oda seven membas akordin to dia family na: Mikael, Meshullam, Sheba, Jorai, Jakan, Zia and Eber.
1CH 5:14 And dia grand-grand papa dem na: Abihail wey Huri born, wey Jaroah born, wey Gilead born, wey Mikael born, wey Jeshishai born, wey Jahdo wey bi Buz pikin, born.
1CH 5:15 Na Guni pikin, Abdeil born Ahi wey bi leader for dis family.
1CH 5:16 Dem dey stay for Bashan and Gilead aria and all di good land wey dey Sharon.
1CH 5:17 (Dem rite all dis tins wen King Jotam dey rule for Judah and King Jeroboam dey rule for Israel.)
1CH 5:18 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe get 44,760 sojas and dem don train dis men well-well on how to dey guide, use swod and shot arrow.
1CH 5:19 Dem go fight Hagrit, Jetur, Nafish and Nodab pipol.
1CH 5:20 Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war.
1CH 5:21 Dem katch 50,000 kamel; 250,000 sheep; 2,000 donkey and 100,000 men as prisonas from dia enemies.
1CH 5:22 Dem kill many enemies, bikos God fight for dem. So dem kon dey stay dat aria until dem karry dem go Babilon as slaves.
1CH 5:23 Di pipol wey dey half of Manasseh tribe kon stay from Bashan go rish Baal-Hermon, Senir and Mount Hermon and dem kon dey many well-well.
1CH 5:24 Di leaders for dia family na: Efer, Ishi, Eliel, Azriel, Jeremaya, Hodevah and Jahdiel. All of dem na strong sojas wey pipol know well-well for di land.
1CH 5:25 Di God wey dia grand-grand papa woship, dem nor gri obey en kommand, instead di nashons wey God porshu komot di land, Israel pipol kon dey woship dia juju.
1CH 5:26 So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.
1CH 6:1 Levi three shidren na: Gershon, Kohat and Merari.
1CH 6:2 Kohat born four shidren: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
1CH 6:3 Amram two sons na: Aaron and Moses and en girl pikin name na Miriam. Aaron get four sons wey bi: Nadab, Abihu, Eleazar and Itama.
1CH 6:4 Eleazar bi Finehas papa, Finehas bi Abishua papa,
1CH 6:5 Abishua bi Bukki papa, Bukki bi Uzzi papa,
1CH 6:6 Uzzi bi Zerahaya papa, Uzzi bi Meraiot papa,
1CH 6:7 Meraiot bi papa, Amaraya bi Ahitub papa, Ahitub bi Zadok papa,
1CH 6:8 Zadok bi Ahimaaz papa, Ahimaaz bi Zabud papa,
1CH 6:9 Zabud kon born Johanan,
1CH 6:10 (Na dis Zabud bi di priest for di temple wey King Solomon build for Jerusalem),
1CH 6:11 Zabud bi Amaraya papa, Amaraya bi Ahitub papa,
1CH 6:12 Ahitub bi Zadok papa, Zadok bi Shallum papa,
1CH 6:13 Shallum bi Hilkaya papa, Hilkaya bi Zabud papa,
1CH 6:14 Zabud bi Seraya papa, Seraya bi Jehozadak papa.
1CH 6:15 King Nebukadnezzar kon karry Jehozadak with Judah and Jerusalem pipol go Babilon as slave.
1CH 6:16 Levi born three sons: Gershom, Kohat and Merari.
1CH 6:17 All of dem still born sons too. Na Gershom born Libni and Shimei:
1CH 6:18 Kohat kon born Amram, Izhar, Hebron and Uzziel;
1CH 6:19 Merari na Mahli and Mushi papa.
1CH 6:20 Gershom shidren-shidren na: Libni, Jahat, Zimma,
1CH 6:21 Joah, Iddo, Zera and Jeaterai.
1CH 6:22 Kohat shidren-shidren na: Amminadab, Korah, Assir,
1CH 6:23 Elkanah, Ebiasaf, Assir,
1CH 6:24 Tahat, Uriel, Uzzaya and Shaul.
1CH 6:25 Elkanah shidren-shidren na Amasai, Ahimot,
1CH 6:26 Elkanah, Zofai, Nahat,
1CH 6:27 Eliab, Jeroham, Elkanah and Samuel.
1CH 6:28 Samuel sons na: Joel (na-im bi senior), sekond to Abijah.
1CH 6:29 Merari shidren-shidren na: Mahli, Libni, Shimei, Uzza,
1CH 6:30 Shimea, Haggiaya and Asaya.
1CH 6:31 Na di men wey David put for di temple make dem dey play music afta dem don karry di Kovenant Box go der, bi dis.
1CH 6:32 Na dem dey do all di work for Tabanako, before King Solomon build temple for Jerusalem.
1CH 6:33 Doz wey serve along with di sons na: From Kohat pipol: Heman wey Samuel pikin Joel born and naim dey lead di first kwaya.
1CH 6:34 Samuel na Elkanah pikin. Jeroham wey Eliel born, na-im bi Elkanah papa. Eliel na Toah pikin.
1CH 6:35 Na Zuf born Toah and na Elkanah bi Zuf papa. Elkanah na Mahat pikin and na Amasai born Mahat.
1CH 6:36 Amasai na Elkanah pikin. Elkanah na Joel pikin and na Zabud born Joel. Zabud na Zefanaya pikin.
1CH 6:37 Tahat wey Assir born, na-im bi Zefanaya papa.
1CH 6:38 Assir na Ebiasaf pikin and na Korah born Ebiasaf. Korah na Izhar pikin. Na Kohat born Izhar. Levi wey Israel born, na-im bi Kohat papa.
1CH 6:39 Na Asaf dey lead di sekond kwaya and na Berekaya bi en papa. Berekaya na Shimea pikin.
1CH 6:40 Mikael wey Baaseaya born, na-im bi Shimea papa. Baaseaya na Malkijah pikin
1CH 6:41 and na Etni born Malkijah. Etni na Zera pikin and na Adaya wey
1CH 6:42 Etan born bi Zera papa. Etan na Zimma pikin and na Shimei born Zimma.
1CH 6:43 Shimei na Jahat pikin. Na Gershom born Jahat. Gershom na Levi pikin.
1CH 6:44 Levi pipol wey serve near dem na Etan wey kom from Merari family. Etan na Kishi pikin and Kishi na Abdi pikin. Abdi na Malluk pikin,
1CH 6:45 and na Hashabaya bi Malluk papa. Hashabaya na Amazaya pikin and na Hilkaya bi Amazaya papa.
1CH 6:46 Amzi wey Bani born, na-im bi Hilkaya papa. Bani na Shema pikin,
1CH 6:47 while Shema na Mahli pikin. Na Mushi born Mahli and na Merari bi Mushi papa. Merari na Levi pikin.
1CH 6:48 Di remainin pipol for Levi wey dem give work for God house, na dem bi dis.
1CH 6:49 Na Aaron and en shidren-shidren dey offa sakrifice for God altar. Na dem dey kare for di holy place and for all di sakrifice wey go make God forgive Israel pipol dia sins. Dem do all dis tins, just as Moses kommand dem.
1CH 6:50 Aaron shidren-shidren na: Eleazar wey born Finehas and na Finehas bi Abishua papa.
1CH 6:51 Abishua na Bukki papa. Na dis Bukki born Uzzi wey bi Zerahaya papa.
1CH 6:52 Na Zerahaya born Meraiot wey bi Amaraya papa and Amaraya born Ahitub.
1CH 6:53 Na Ahitub bi Zadok and Ahimaaz papa.
1CH 6:54 Aaron wey kom from Kohat family with en shidren-shidren, na where e dey stay bi dis. Di first share wey dem give Levi pipol for di land, na dem take am.
1CH 6:55 Na dem get Hebron near Judah and all di land wey dey near am.
1CH 6:56 Di lands and village wey dey di town, dem gi-am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.
1CH 6:57 Dis na di towns wey dem give Aaron shidren-shidren: Hebron, Libnah, Jattir, Eshtemoa,
1CH 6:58 Hilez, Debir,
1CH 6:59 Ashan and Bet-Shemesh with all dia land.
1CH 6:60 Di towns and lands wey dem give dem for Benjamin aria na: Gibeah, Alemet and Anatot. So all di towns na thirteen.
1CH 6:61 Dem give di rest pipol for Kohat shidren-shidren ten towns, wey bi half of Manasseh tribe.
1CH 6:62 Dem give Gershom shidren-shidren, thirteen towns for Issakar, Asher, Naftali and East Manasseh wey dey for Bashan aria.
1CH 6:63 Na so too, dem still give all Merari family twelf towns for Reuben, Gad, and Zebulun aria.
1CH 6:64 Na like dis too, Israel pipol take give Levi pipol dia towns and lands.
1CH 6:65 Di towns for Judah, Simeon and Benjamin aria wey dem rite down before, dem still give dem to Levi pipol.
1CH 6:66 Some among di family, dem give dem Kohat towns and dia lands wey dey Efraim aria.
1CH 6:67 Dem still give dem Shekem towns and some lands wey dey for Efraim hill kountry with Geza and dia lands too.
1CH 6:68 Dem still give Levi pipol Jokmeam, Bet-Horon,
1CH 6:69 Aijalon and Gat-Rimmon towns with all dia lands.
1CH 6:70 For West Manasseh aria, dem give dem Aner and Bileam towns with all dia land.
1CH 6:71 Dis na di land and field wey dem give Gershom tribe: For East Manasseh aria, dem give dem: Golan for Bashan and Ashtarot.
1CH 6:72 For Issakar aria, dem give dem: Kedesh, Daberat,
1CH 6:73 Ramot and Anem.
1CH 6:74 For Asher aria, dem give dem: Mashal, Abdon,
1CH 6:75 Hukok and Rehob.
1CH 6:76 For Naftali aria, dem give dem: Kedesh for Galilee, Hammon and Kiriataim.
1CH 6:77 Di remainin family wey dey Merari tribe, na di land wey dem give dem bi dis: For Zebulun aria, dem give dem: Rimmono and Tabor.
1CH 6:78 For Reuben aria wey dey di east side for Jordan River afta Jeriko, dem give dem: Beza, Jahza,
1CH 6:79 Kedemot and Mefaat.
1CH 6:80 For Gad aria, dem give dem: Ramot for Gilead, Mahanaim,
1CH 6:81 Heshbon and Jazer.
1CH 7:1 Issakar four sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.
1CH 7:2 Tola six sons na: Uzzi, Refaaya, Jeriel, Jahmai, Ibsam and Shemuel. Dem bi popula sojas and na dem dey head each family. For di time wen David bi king, di wariors for di family na 22,600.
1CH 7:3 Uzzi born Izrahaya Izrahaya kon born Mikael, Obadaya, Joel and Isshaya and all of dem dey head dia family.
1CH 7:4 Dem get many wifes and shidren and dem still get 36,000 wariors.
1CH 7:5 All di wariors wey dem rekord for Issakar family na 87,000.
1CH 7:6 Benjamin born three sons: Bela, Beka and Jediael.
1CH 7:7 Bela kon born five sons: Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimot and Iri.
1CH 7:8 Beka born nine sons: Zemirah, Joash, Elieza, Elioenai, Omri, Jerimot, Abijah, Anatot and Alemet.
1CH 7:9 All of dem na leader for di family. Na 20,200 wariors dem rekord for di family.
1CH 7:10 Jediael born one pikin wey dem dey koll Bilhan. Bilhan born seven sons: Jeush, Benjamin, Ehud, Kenaana, Zetan, Tarshish and Ahishahar.
1CH 7:11 Dem dey head dia family. Na 17,200 wariors dey ready for war for dis family.
1CH 7:12 Ir sons na Shuppim and Huppim. Na Aher born Hushim.
1CH 7:13 Naftali born four sons: Jahziel, Guni, Jeza and Shallum. Dem bi Bilhah shidren.
1CH 7:14 Manasseh girl-friend for Aramean born two sons for am and dem bi: Asriel and Makir. Na Makir born Gilead.
1CH 7:15 Makir marry wife for Huppim and Shuppim. (En sista name na Maaka.) Zelofehad na Manasseh sekond son and na only girl shidren e born.
1CH 7:16 Maaka wey bi Makir wife, born two boys: Peresh and Sheresh. Peresh sons na: Ulam and Rekem.
1CH 7:17 Ulam pikin na Bedan. Ramot wey Makir born, na en shidren-shidren bi dis and na Manasseh bi Gilead grand-grand papa.
1CH 7:18 Ramot sista, Hammoleket born three sons: Ishhod, Abiezer and Mahlah.
1CH 7:19 Shemida sons na: Ahian, Shekem, Likhi and Aniam.
1CH 7:20 Efraim shidren-shidren na: Shutela, Bered, Tahat, Eleada, Tahat and
1CH 7:21 Zabad Shutela. (Afta Shutela, Efraim still born Ezer and Elead wey dem kill wen dem go tif animal for Gat pipol land.)
1CH 7:22 Efraim wey bi dia papa kry for dem well-well and en brodas kon dey sorry for am.
1CH 7:23 E sleep with en wife again and e kon born and dem koll di pikin Beraya, bikos di family don face trobol well-well.
1CH 7:24 Efraim born one girl and en name na Sheerah. Na en build Uppa and Lowa Bet-Horon and Uzzen Sheerah towns.
1CH 7:25 Efraim still born one son, Refah. Refah shidren-shidren na: Reshef, Telah, Tahan,
1CH 7:26 Ladan, Ammihud, Elishama,
1CH 7:27 Nun and Joshua.
1CH 7:28 Dia propaty and lands na Bethel and di towns wey dey near am, go rish Naaran for di east and Geza for di west. Dem still stay for Shekem and Ayyah and all di towns wey near dem.
1CH 7:29 Na Manasseh shidren-shidren dey kontrol Bet-Shean, Taanak, Megiddo, Dor and di oda towns wey dey near dem. Josef wey bi Jakob pikin, na en shidren-shidren stay all dis towns.
1CH 7:30 Na Asher shidren-shidren bi dis: e born four sons: Imnah, Ishvah, Ishvi and Beraya with one dota wey en name na Serah.
1CH 7:31 Beraya born two sons: Heba and Malkiel. Na Malkiel bi Birzait papa.
1CH 7:32 Heba born three sons: Jaflet, Shoma and Hotam with one dota, Shua.
1CH 7:33 Jaflet still born three sons: Pasak, Bimhal and Ashvat.
1CH 7:34 En broda Shema sons na: Ahi, Rohgah, Hubbah and Aram: Rohgah, Hubbah and Aram.
1CH 7:35 While dia last broda, Helem born four sons: Zofah, Imna, Shelesh and Amal.
1CH 7:36 Zofah shidren-shidren na: Suah, Harnefa, Shual, Beri, Imrah,
1CH 7:37 Beza, Hod, Shamma, Shilshah, Itran and Bera.
1CH 7:38 Jeta shidren-shidren na: Jefunneh, Pispa and Ara.
1CH 7:39 While Ulla shidren-shidren na: Arah, Hanniel and Rizia.
1CH 7:40 All dis pipol na Asher shidren-shidren. Dem dey head dia family and dem bi popula sojas. Asher wariors na 26,000 just as dem rekord am.
1CH 8:1 Benjamin first son na Bela, sekond to Ashbel, before Ahara,
1CH 8:2 Nohah and Rafa.
1CH 8:3 Bela shidren-shidren na: Addar, Gera, Abihud,
1CH 8:4 Abishua, Naaman, Ahoah,
1CH 8:5 Gera, Shefufan and Huram.
1CH 8:6 Dis na Ehud shidren-shidren. Dem bi di head for dia family and na Gibeah dem dey stay, but dem force dem go stay for Manahat.
1CH 8:7 Ehud shidren na Naaman, Ahijah and Gera. Gera, wey bi Uzza and Ahihud papa, na-im lead dem for di journey.
1CH 8:8 Afta Shaharaim porshu en too wifes, Hushim and Baara, e still born shidren wen e dey Moab land.
1CH 8:9 E marry Hodesh wey born seven sons for am and dia names na: Jobab, Zibia, Mesha, Malkam,
1CH 8:10 Jeuz, Sakia and Mirmah. All en shidren na leaders for dia family.
1CH 8:11 Hushim still born two sons for am: Abitub and Elpaal.
1CH 8:12 Elpaal born three sons: Eber, Misham and Shemed. Na Shemed build Ono and Lod town with all di village wey dey near am.
1CH 8:13 Beraya and Shema na leaders for dia family and dem go stay for Aijalon kon porshu doz wey dey stay for Gat town komot.
1CH 8:14 Beraya shidren na: Ahio, Shashak, Jerimot,
1CH 8:15 Zebadaya, Arad, Eder,
1CH 8:16 Mikael, Ishpah and Joha.
1CH 8:17 Elpaal shidren na: Zebadaya, Meshullam, Hizki, Heba,
1CH 8:18 Ishmerai, Izlaya and Jobab.
1CH 8:19 Shimei shidren na: Jakim, Zikri, Zabdi,
1CH 8:20 Elienai, Zilletai, Eliel,
1CH 8:21 Adaya, Beraaya and Shimrat.
1CH 8:22 Shashak shidren na: Ishpan, Eber, Eliel,
1CH 8:23 Abdon, Zikri, Hanan,
1CH 8:24 Hananaya, Elam, Antotijah,
1CH 8:25 Ifdeaya and Penuel.
1CH 8:26 Jeroham shidren na: Shamsheraya, Sheharaya, Atalaya
1CH 8:27 Jaareshaya, Elijah and Zikri.
1CH 8:28 All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.
1CH 8:29 Na Jeiel build Gibeon town. En wife na Maaka
1CH 8:30 and en first pikin name na Abdon, sekond to Zur, before Kish, Baal, Ner, Nadab,
1CH 8:31 Gedor, Ahio, Zeka
1CH 8:32 and Miklot wey bi Shimea papa. All dis family stay for Jerusalem near dia oda family pipol.
1CH 8:33 Na Ner bi Kish papa and na Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.
1CH 8:34 Na Jonatan bi Meribbaal papa and Merib-Baal born Mikah.
1CH 8:35 Mikah born four sons: Piton, Melek, Tarea and Ahaz.
1CH 8:36 Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah born three sons: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa.
1CH 8:37 Na Moza born Binea, Binea born Rafah wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.
1CH 8:38 Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan.
1CH 8:39 Azel broda, Eshek born three sons: Ulam, Jeush and Elifelet.
1CH 8:40 Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi. Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.
1CH 9:1 Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.
1CH 9:2 Doz wey first kom back to dia land na: di priests, Levi pipol, doz wey dey work for di temple and some few Israel pipol.
1CH 9:3 Some of di pipol wey kom back to Jerusalem na from Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes.
1CH 9:4 Utai family dey among di ones wey kom back to Jerusalem. Utai na Ammihud pikin and na Omri bi en grand-papa. Na Imri wey Bani born, bi Omri papa and na Perez wey Judah born bi Bani papa.
1CH 9:5 Odas still kom back from Shilon family and dem bi Asaya wey bi di first-born and en sons.
1CH 9:6 From Zera family, Jeuel and en family kom back too. Na 690 family for Judah kom back to Jerusalem.
1CH 9:7 Doz wey kom back from Benjamin tribe na: Sallu wey Meshullam born. Meshullam na Hodevah pikin and na Hassenuah bi Hodevah papa.
1CH 9:8 Ibneaya wey Jeroham born naim bi Hassenuah papa. Jeroham papa na Elah wey Uzzi born and na Mikri bi en grand-papa. Meshullam wey bi Shefataya pikin, na Reuel wey Ibnijah born, bi en grand-papa.
1CH 9:9 Na 956 family kom back from Benjamin tribe and dem rite dia names for di rekord book. All of dem na leader for dia family.
1CH 9:10 Di priests wey kom back to Jerusalem na: Jedaya, Jehoiarib, Jakin,
1CH 9:11 and Zabud wey bi di leader for God Temple. Na Hilkaya wey Meshullam born bi en papa. Zadok wey bi Meraiot pikin, na-im bi Meshullam papa. Meraiot na Ahitub pikin.
1CH 9:12 E still get Adaya wey Pashhur pikin Jeroham born and na Malkijah bi Pashhur papa. Adiel pikin, Priest Massai still dey and na Jahzerah bi en grand-papa. Na Meshullam born Jahzerah and na Meshillemit wey Imma born, bi Meshullam papa.
1CH 9:13 Dem bi 1,760 priest wey kom back and dem bi leader for dia family. Dis men dey work well-well and na dem dey do God work for di temple.
1CH 9:14 Levi pipol wey kom back to Jerusalem na: Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born wey kom from Merari tribe;
1CH 9:15 Bakbakkar; Heresh, Galal and Matanaya wey Mikah born and dis Mikah, na Asaf grand-pikin wey Zikri born.
1CH 9:16 E still get Shemaya pikin, Obadaya and na Galal wey Jedutun born, bi en grand-papa. Berakaya wey Asa born, na-im bi Jedutun papa. Na Elkanah bi Asa papa and na Netofat pipol land dem dey stay.
1CH 9:17 Di temple guards wey kom back to Jerusalem na: Shallum, Akkub, Talmon, Ahiman and dia brodas. Na Shallum bi dia leader.
1CH 9:18 Till today, na dia family dey guide di east side for di king gate. Before-before, na dem dey guide di gate wey dey for Levi pipol kamp.
1CH 9:19 Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before.
1CH 9:20 Finehas wey bi Eleazar pikin, na-im dey lead dem before and God dey with am.
1CH 9:21 Zekaraya wey bi Meshelemaya pikin, don still bi guide before for Tabanako.
1CH 9:22 All di men wey guide di gates na 212. Dem register dem akordin to where dem stay. Na King David and Samuel wey bi profet, put dem for dis pozishon.
1CH 9:23 Na dem with dia shidren-shidren still dey guide di temple gate.
1CH 9:24 Doz wey dey guide di gate dey for di four side wey face nort, sout, east and west.
1CH 9:25 Dia family dey kom help and join dem guide for seven days.
1CH 9:26 Di four main guide na from Levi tribe where dem for bi leaders. Na dem still dey kare for di store room and evritin wey dem keep for di temple.
1CH 9:27 Dem dey sleep near di temple, bikos na dia work to guide and open di gate evritime.
1CH 9:28 Some of dem dey keep di tins wey dem take dey woship God for di temple. Na dem dey bring and keep dem anytime wey dem use di tins finish.
1CH 9:29 Na dem dey keep di holy tins, flour, wine, olive oil, incense and spices.
1CH 9:30 But na di priests dey mix di spices.
1CH 9:31 Mattitaya wey kom from Levi tribe, wey bi Shallum first pikin for Korah family, na-im dey bake di bread wey dem dey use for ofrin.
1CH 9:32 Na Kohat family pipol dey bake di holy bread for di temple wen Sabat Day rish.
1CH 9:33 Some family for Levi; dia work na to dey play music for di temple. Doz wey dey head dis family dey stay di rooms for di temple and dat na only wetin dem dey do, bikos dem fit koll dem to play, both for day and nite.
1CH 9:34 Doz wey dem rite dia name down, dey head families for Levi tribe and dem dey stay for Jerusalem.
1CH 9:35 Jeiel (wey bi Gibeon papa) dey stay for Gibeon town. En wife name na Maaka.
1CH 9:36 En first pikin na Abdon, before Zur, Kish, Baal, Ner, Nadab,
1CH 9:37 Gedor, Ahio, Zekaraya and Miklot
1CH 9:38 wey bi Shimea papa. Dem dey stay Jerusalem near dia oda family.
1CH 9:39 Na Ner bi Kish papa and na dis Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.
1CH 9:40 Na Jonatan bi Merib-Baal papa and na Merib-Baal born Mikah.
1CH 9:41 Mikah four sons na: Piton, Melek, Tarea and Ahaz.
1CH 9:42 Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah three sons na: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa.
1CH 9:43 Moza born Binea; Binea born Rafaaya wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.
1CH 9:44 Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan. Na Azel pikin dem bi.
1CH 10:1 Filistia pipol fight with Israel pipol for Gilboa mountin. Dem kill many Israel pipol for der and di ones wey remain, run komot from der.
1CH 10:2 But Filistia pipol porshu dem katch kon kill Saul three shidren: Jonatan, Abinadab and Malki-Shua.
1CH 10:3 Di fight strong well-well for where Saul dey, so di enemies spear kon tosh and wound King Saul.
1CH 10:4 Den Saul tell di boy wey karry en swod sey, “Make yu kill mi with yor swod, so dat all dis Filistia pipol wey nor know God nor go kom sofa mi.” But fear nor let di boy do am. So Saul take en own swod take kill ensef.
1CH 10:5 Wen di boy si sey Saul don die, en too kon kill ensef.
1CH 10:6 So Saul with en three shidren die togeda and nobody for en family dey to rule again.
1CH 10:7 Wen Israel pipol wey dey Jezrel Valley hear sey di sojas don run and Saul with en shidren don die, dem kon run leave dia towns. Den Filistia pipol kon seize and start to stay di town.
1CH 10:8 Di next day wen Filistia pipol kom gada tins from di pipol wey dem kill, dem kon si sey Saul with en three shidren don die for Gilboa mountin.
1CH 10:9 Dem kut Saul head komot, remove en war klot kon send message go evriwhere for Filistia sey, make dem tell dia pipol and juju about di good news.
1CH 10:10 Dem put en weapon for one of dia temple kon hang en head for dia juju wey dem dey koll Dagon, temple.
1CH 10:11 Wen Jabesh pipol for Ramot hear wetin Filistia pipol do to Saul,
1CH 10:12 doz wey get heart kon go take Saul and en shidren body go beri for Jabesh. Dem beri dem under one oak tree kon fast for seven days.
1CH 10:13 Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am
1CH 10:14 instead of God wey go guide am. So God kill-am kon make David wey bi Jesse pikin, king for Israel.
1CH 11:1 Den all Israel pipol go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood.
1CH 11:2 Before-before, even wen Saul still bi awa king, yu karry us go fight and God wey bi yor God promise yu sey, yu go lead en pipol as dia king.”
1CH 11:3 Wen di leaders for Israel meet David for Hebron, e make agriment with dem and dem anoint am as king for Israel, just as God promise dem thru Samuel.
1CH 11:4 David and Israel pipol go attack Jerusalem. Dat time, dem dey koll Jerusalem, “Jebus”, bikos na Jebus pipol dey stay di land.
1CH 11:5 Jebus pipol kon tell David sey e nor go fit enter di town, but David seize where God propaty dey for Zion, so dem kon dey koll di place, “David Town.”
1CH 11:6 David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga.
1CH 11:7 David go stay for where dia betta propaty dey and na dis make dem dey koll am, David Town.
1CH 11:8 David build di town again. E start from where big land dey for di east for di hill and Joab kon build di remainin side.
1CH 11:9 David kon dey strong evriday, bikos di Oga God dey with am.
1CH 11:10 Dis na David strong sojas wey help and make en kingdom stand for Israel.
1CH 11:11 Dia names na: Jeshobeam wey kom from Hakmon tribe and naim dey head di ofisas. E kill three hundred men with en spear for only one war.
1CH 11:12 Di next one na Dodo pikin, Eleazar wey kom from Ahohi tribe.
1CH 11:13 E follow David fight Filistia pipol for Pass Dammim. E dey one side for di field wey barley full, even wen Israel pipol bigin run,
1CH 11:14 en and en men dey di field centre kon fight Filistia pipol and God make dem win.
1CH 11:15 One day, three of en strong sojas among di thirty kon go one rock where David dey stay near Adullam Kave, while some Filistia pipol dey Refah Valley.
1CH 11:16 For dat time, David dey one hill wey dem guide well-well and some Filistia pipol dey for Betlehem.
1CH 11:17 David dey hongry for wota so e kon sey, “I wish pesin fit go draw wota kon give mi from di well wey dey for Betlehem gate, so dat I go drink!”
1CH 11:18 Di three strong sojas kon force diasef pass Filistia pipol kamp, draw wota from di well kon give David. But e nor gri drink am, instead, e pour am for groun as ofrin to God
1CH 11:19 kon sey, “I nor fit drink dis wota, bikos e go bi like sey I dey drink dis men wey risk dia life, blood!” So e nor drink am. So dis na wetin di three strong sojas do.
1CH 11:20 Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas.
1CH 11:21 Na-im popula pass among “Di Three” and e kon bi dia leader, even doh e nor dey join di three.
1CH 11:22 Jehoiada pikin Benaya wey kom from Kabzeel, na anoda strong soja. E still do many big tins kon kill two strong men for Moab. One day, e enter one pit go kill lion.
1CH 11:23 E kill one Egypt man wey hold big spear for hand and tall rish seven and half fit. Benaya attack di man, kollect en spear kon kill-am.
1CH 11:24 Dis na di strong tin wey Benaya do and e dey among, “Di Thirty.”
1CH 11:25 Among di thirty, naim popula pass, but dem nor know am rish di three strong sojas. David kon make am di bodyguards oga.
1CH 11:26 Di oda sojas wey do well na: Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin wey kom from Betlehem;
1CH 11:27 Shammot wey kom from Harod; Helez wey kom from Pelon;
1CH 11:28 Ikkesh pikin, Ira wey kom from Tekoa; Abiezer wey kom from Anatot;
1CH 11:29 Sibbekai wey kom from Hushah; Ilai wey kom from Ahohi;
1CH 11:30 Maharai wey kom from Netofat; Baanah pikin, Heled wey kom from Netofat;
1CH 11:31 Ribai pikin, Itai wey kom from Gibeah for Benjamin aria; Benaya wey kom from Piraton;
1CH 11:32 Hurai wey kom from Gaash Valley; Abiel wey kom from Arbat;
1CH 11:33 Azmavet wey kom from Bahurim; Eliahba wey kom from Shaalbon,
1CH 11:34 Hashem wey Gizon born; Shagee pikin, Jonatan wey kom from Harar;
1CH 11:35 Sakar pikin, Ahiam wey kom from Harar; Elifal wey Ur born;
1CH 11:36 Hefa wey kom from Mekera; Ahijah wey kom from Pelon;
1CH 11:37 Hezro wey kom from Karmel; Naarai wey kom from Ezbai;
1CH 11:38 Joel wey bi Natan broda; Mibhar wey Hagri born;
1CH 11:39 Zelek wey kom from Ammon; Naharai wey kom from Beerot. Na dis Naharai dey hold Zeruaya pikin, Joab swod.
1CH 11:40 Ira with Gareb wey kom from Jattir;
1CH 11:41 Uriaya wey kom from Hit; Zabad wey Ahlai born.
1CH 11:42 Shiza pikin, Adina wey kom from Reuben tribe and di thirty sojas;
1CH 11:43 Hanan wey Maaka born; Joshafat wey kom from Mitnite;
1CH 11:44 Uzzia wey kom from Ashterah; Shama and Jeiel, Hotam shidren wey kom from Aroer tribe;
1CH 11:45 Jediael wey Shimri, en broda Joha wey kom from Tiz born;
1CH 11:46 Eliel wey kom from Mahavah; Jeribai and Joshavaya wey bi Elnaam shidren; Itmah wey kom from Moab tribe.
1CH 11:47 Den Eliel, Obed and Jaasiel wey kom from Mezoba.
1CH 12:1 Dis na di men wey join David for Ziklag for di time wey e dey run from Saul wey bi Kish pikin and dis men dey among di sojas wey help am for war.
1CH 12:2 Dem kom from Benjamin tribe and na der Saul from kom. Dem sabi shot arrows and trow stones well with dia two hand.
1CH 12:3 Na Ahiezer and Joash wey bi Shemaah shidren, wey kom from Gibeah, bi dia kommander. Di sojas na: Jeziel and Pelet wey Azmavet born; Berakah and Jehu wey kom from Anatot.
1CH 12:4 Ishmaya wey kom from Gibeon and e popula well-well, bikos e dey join “Di Thirty.” Jeremaya, Jahaziel, Johanan and Jozabad wey kom from Gederah;
1CH 12:5 Eluzai, Jerimot, Bealaya, Shemaraya and Shefataya wey kom from Haruf;
1CH 12:6 Elkanah, Isshaya, Azarel, Joeza and Jashobeam wey kom from Korah family;
1CH 12:7 Joelah and Zebadaya wey bi Jeroham shidren and dem kom from Gedor.
1CH 12:8 Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.
1CH 12:9 Na Ezer bi dia leader, follow by Obadaya, Eliab,
1CH 12:10 Mishmannah, Jeremaya,
1CH 12:11 Attai, Eliel,
1CH 12:12 Johanan, Elzabad,
1CH 12:13 Jeremaya and Makbannai.
1CH 12:14 Some of dis men wey kom from Gad tribe na senior offisa wey dey kommand tazon pipol, while di odas dey kommand hundred.
1CH 12:15 For di first mont for di year, wen Jordan River dey flow enter land, dem kon cross go skata di pipol wey dey stay di valley, for di east and west side for di river.
1CH 12:16 Some from Benjamin and Judah tribe still go meet David.
1CH 12:17 David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”
1CH 12:18 Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.
1CH 12:19 Some from Manasseh tribe still go meet David wen e follow Filistia pipol go fight Saul. (But, e nor help di Filistia pipol, bikos dia king dey fear sey e go sell dem give Saul wey bi en oga before, so dem send David and en men go back to Ziklag.)
1CH 12:20 Wen David go Ziklag, Manasseh men wey join am na: Adnah, Jozabad, Jediael, Mikael, Jozabad, Elihu and Zilletai and na one-one tazon sojas dem dey lead.
1CH 12:21 Dem bi David ofisas, bikos dem bi strong sojas. Leta, dem kon bi ofisas among Israel sojas.
1CH 12:22 Na almost evriday new pipol dey kom join David sojas. So en and en sojas kon plenty well-well.
1CH 12:23 Dis na di names of di strong sojas wey kom join David with dia leaders for Hebron, so dat David go bi king afta Saul, just as God tok am:
1CH 12:24 From Judah: na 6,800 sojas wey dem don train to karry shield and spear.
1CH 12:25 From Simeon: na 7,100 sojas.
1CH 12:26 From Levi: na 4,600 sojas.
1CH 12:27 Doz wey follow Jehoiada kom from Aaron family na: 3,700 with
1CH 12:28 Zadok wey sabi fight well-well and 22 oda leaders for di family.
1CH 12:29 From Benjamin wey bi Saul tribe: na 3,000 men wey dey loyal to Saul before.
1CH 12:30 From Efraim: na 20,800 popula men for dia village.
1CH 12:31 From half of Manasseh tribe: na 18,000 sojas wey dem sey make dem kon make David king.
1CH 12:32 From Issakar: na 200 leaders and dia family; dem undastand evritin, plus wetin Israel pipol suppose do.
1CH 12:33 From Zebulun: na 50,000 sojas wey karry difren weapon and dem dey ready for war.
1CH 12:34 From Naftali: na 1,000 ofisas with 37,000 sojas with dia shield and spear.
1CH 12:35 From Dan: na 28,600 sojas and dem dey ready for war.
1CH 12:36 From Asher: na 40,000 sojas and dem dey ready for war.
1CH 12:37 Doz wey kom from di oda side for Jordan River: From Reuben, Gad, and di half tribe for Manasseh: na 120,000 sojas wey karry difren weapon.
1CH 12:38 All dis men na sojas wey dey ready to fight. Dem kom Hebron kon make David king ova Israel pipol. In-short, evribody for Israel gri sey make David bi dia king.
1CH 12:39 Dem use three days take follow David chop and drink, bikos dia pipol give dem evritin wey dem wont.
1CH 12:40 Even dia neighbours; doz for nort wey dey far like: Issakar, Zebulun and Naftali tribe, still bring donkey, kamel and melu kon load dem with food, flour, fig, raisin, wine and olive oil. Dem still bring sheep, so dat di men go chop and Israel pipol kon dey happy more-more.
1CH 13:1 King David koll and tok to di ofisas with
1CH 13:2 Israel pipol sey, “If una and di Oga awa God go like am, den e betta make wi send message go meet awa remainin brodas, priests and Levi pipol for dia towns sey make dem gada kom
1CH 13:3 follow us go karry God Kovenant Box, wey dem abandon thru-out di time wey Saul bi king.”
1CH 13:4 Wetin David tok, kon make di pipol dey happy.
1CH 13:5 So David gada Israel pipol from Shihor River for Egypt go rish Hamat, so dat dem go-go bring God Kovenant Box from Kiriat-Jearim.
1CH 13:6 David and all di pipol kon go Baalah town (wey bi Kiriat-Jearim), for Judah go bring God Kovenant Box wey dey on-top di creature wey get feada. Na God name dem dey koll di box.
1CH 13:7 Dem bring di Kovenant box kom out from Abinadab house, put am for one new truck and na Uzza and Ahio dey guide am.
1CH 13:8 David with all di pipol kon dey dance with dia heart to honor God. Dem sing dey play instrument, harp, drums, cymbals and trumpets.
1CH 13:9 Wen dem rish where dem for dey separate wheat for Kidon, di truck wey dem put di Kovenant Box kon dey shake like sey e won fall, so Uzza kon hold di box make e for nor fall.
1CH 13:10 At wons, God vex kon kill Uzza, bikos e tosh di box.
1CH 13:11 David vex well-well, bikos God kill Uzza, so e koll di place Perez Uzza and na-im dem dey koll am till today.
1CH 13:12 Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?”
1CH 13:13 So David nor karry am go Jerusalem again, instead, e karry am go Obed-Edom wey kom from Gat, house.
1CH 13:14 God Kovenant Box dey Obed-Edom house for three monts, so God bless Obed-Edom family and evritin wey dem get.
1CH 14:1 King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.
1CH 14:2 David know sey na God make am king for Israel and E dey prosper en kingdom and pipol.
1CH 14:3 David marry plenty wifes for Jerusalem and e born many shidren.
1CH 14:4 Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon,
1CH 14:5 Ibhar, Elishua, Elpelet,
1CH 14:6 Nogah, Nefeg, Jafia,
1CH 14:7 Elishamah, Beeliada and Elifelet.
1CH 14:8 Wen Filistia pipol hear sey dem don make David king for Israel, dia sojas gada won kon go fight am. But David hear dia plan, so en and en men kon mash go meet dem.
1CH 14:9 Filistia pipol go skata evriwhere for Refah Valley.
1CH 14:10 So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?” God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”
1CH 14:11 So David attack and win dem for Baal-Perazim. David kon sey, “My Oga God don use mi take distroy my enemies like wota wey dey rush fit force.” So E kon koll di place, “Baal-Perazim.”
1CH 14:12 Wen Filistia pipol dey run, dem leave dia juju, so David orda en pipol make dem burn dem trowey.
1CH 14:13 E nor too tey before Filistia pipol go skata di valley again.
1CH 14:14 Den David ask God again and E sey, “Nor attack dem from dis side, but go pass thru where di Balsam trees dey.
1CH 14:15 And wen yu hear pipol dey mash on-top di trees, make yu attack dem bikos, I go mash go yor front go distroy Filistia sojas.”
1CH 14:16 David kon do as God kommand, so e drive Filistia pipol from Gibeon pass Geza.
1CH 14:17 David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.
1CH 15:1 David build many house for ensef for en own town. E still make one place for God Kovenant Box.
1CH 15:2 David kon sey, “Na only Levi pipol go karry di Kovenant Box, bikos na dem God choose to karry di box and serve am forever.”
1CH 15:3 So David gada Israel pipol go Jerusalem make dem go bring di Kovenant Box kom di place wey e make for am.
1CH 15:4 So e sey make dem koll Levi pipol and Aaron shidren-shidren kom.
1CH 15:5 From Kohat family: dem koll 120 pipol and na Uriel dey lead dem.
1CH 15:6 From Merari family: dem koll 220 pipol and na Asaya dey lead dem.
1CH 15:7 From Gershom family: dem koll 130 pipol and na Joel dey lead dem.
1CH 15:8 From Elizafan family: dem koll 200 pipol and na Shemaya dey lead dem.
1CH 15:9 From Hebron family: dem koll 80 pipol and na Eliel dey lead dem
1CH 15:10 and from Uzziel family: dem koll 112 pipol and na Amminadab dey lead dem.
1CH 15:11 David koll Priest Zadok and Priest Abiatar with six pipol form Levi tribe and dem bi: Uriel, Asaya, Joel, Shemaya, Eliel and Amminadab.
1CH 15:12 E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.
1CH 15:13 God ponish us, bikos una nor dey der to karry am for di first time and wi nor woship am as wi suppose to.”
1CH 15:14 Den Levi pipol and di priest kon klean demsef, so dat dem go fit karry Israel God Kovenant Box.
1CH 15:15 Levi pipol karry di box for pole kon put am for dia shoulder, just as God kommand thru Moses, en savant.
1CH 15:16 David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”
1CH 15:17 So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.
1CH 15:18 Di pipol wey dem choose to assist dem na: Zekaraya, Jaaziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Benaya Maaseaya, Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya and Obed-Edom and Jeiel wey dey guide di gate.
1CH 15:19 Doz wey dey sing na Heman, Asaf, Etan and na dem dey play di bronze cymbals;
1CH 15:20 Zekaraya, Aziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Maaseaya and Benaya dey play di harps.
1CH 15:21 Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya, Obed-Edom, Jeiel and Azazaya dey play di lyres.
1CH 15:22 Bikos Kenanaya sabi play music well-well, dem kon make am dia leader.
1CH 15:23 Dem choose Berakaya and Elkanah make dem dey guide di Kovenant Box.
1CH 15:24 Doz wey dem choose to blow trumpet for di Kovenant Box front na: Shebanaya, Joshafat, Netanel, Amasai, Zekaraya, Benaya and Elieza and all of dem na priests. Dem still choose Obed-Edom and Jehaya make dem dey guide di box too.
1CH 15:25 So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.
1CH 15:26 Dem sakrifice seven bull and seven ram, bikos God dey help di Levi pipol wey karry di Kovenant Box.
1CH 15:27 Doz wey dey play music, with Shenanaya wey bi dia leader and Levi pipol wey karry di box, wear one robe wey dem make with fine linen. David too dress like priest and e wear robe too.
1CH 15:28 So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.
1CH 15:29 As dem bring di box enter di town, Saul dota, Mikal look thru window kon si David en husband dey dance anyhow, so e kon dey vex for am.
1CH 16:1 Dem karry di Kovenant Box go put for di tent wey David make for am. Den dem do sakrifice kon woship God.
1CH 16:2 Afta David don give di sakrifice finish, e kon bless di pipol with God name and
1CH 16:3 all of dem kon chop beleful. E give bread, meat wey dem roast and rice to each pesin for Israel.
1CH 16:4 David tell some Levi pipol sey, make dem lead di pipol as dem dey woship for di Kovenant Box front kon dey sing and praiz di Oga wey bi Israel pipol God.
1CH 16:5 Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.
1CH 16:6 Na Priest Benaya and Priest Jahaziel dey blow di trumpet for di Kovenant Box front.
1CH 16:7 Dat day, David first sey make Asaf with all Levi pipol sing dis song take tank God:
1CH 16:8 “Make una tank and koll God name! Make una let di whole world know di tins wey E do!
1CH 16:9 Make una sing dey praiz God! Make una tok about di wonderful tins wey E dey do!
1CH 16:10 Make una boast about en name wey dey holy! Doz wey dey serve am, make una happy!
1CH 16:11 Make una go meet God and E go help una! Make una always dey woship am!
1CH 16:12 Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,
1CH 16:13 bikos na una bi Israel shidren-shidren; God savant; pipol wey kom from Jakob wey God don choose as en own!
1CH 16:14 Na-im bi di Oga awa God! Na-im dey judge di whole eart.
1CH 16:15 Make una nor forget wetin dey God kovenant; en kovenant wey go last forever,
1CH 16:16 just as E promise Abraham and Isaak.
1CH 16:17 God give en kovenant to Jakob and na kovenant wey go last forever.
1CH 16:18 E sey, ‘I go give yu Kanaan land and e go bi yor own.’
1CH 16:19 Dat time, God pipol nor many and dem bi strenjas for di land.
1CH 16:20 Dem dey waka from kountry to kountry and from town to town.
1CH 16:21 God nor let anybody opress dem; instead, E ponish kings bikos of dem kon sey:
1CH 16:22 ‘Make una nor tosh di pipol wey I choose or trobol my profets.’
1CH 16:23 Make evribody for di eart sing to God! Make una always dey tok about en goodness and how E take dey save pesin.
1CH 16:24 Make una tell di world about en glory and di big-big tins wey E dey do.
1CH 16:25 Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.
1CH 16:26 Di gods for oda towns nor mean anytin, but na God make di heavens.
1CH 16:27 Na-im get glory and majesty! Na-im dey give us pawa and joy.
1CH 16:28 Make evribody praiz God! Make una praiz God for en glory and how E big rish.
1CH 16:29 Make una give God di praiz wey bi en own! Make una bring ofrin kom en present! Make una dey holy kon woship God!
1CH 16:30 Make evritin wey dey dis world fear God! God don make di world stand and nor-tin go fit move or break am.
1CH 16:31 Make di heavens and eart dey happy! Make una tell di whole world sey, na God bi king.
1CH 16:32 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut! Make di grass and evritin wey dey inside dem bigin dance!
1CH 16:33 Den make all di trees for bush shaut with joy for God, bikos E dey kom judge di world.
1CH 16:34 Make una tank God, bikos E dey good, en love go dey forever.
1CH 16:35 Make una pray kon sey, ‘Awa Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us kon save us from dis nashons! Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’
1CH 16:36 Make di Oga wey bi Israel God get all di praiz from naw and forever.” Den all di pipol ansa, “Amen! Wi go praiz di Oga awa God!”
1CH 16:37 King David sey make Asaf and some Levi pipol dey lead di pipol as dem dey woship God for di tent where di Kovenant Box dey and na der dem go for dey do dia work evriday.
1CH 16:38 Dem still choose Obed-Edom wey bi Jedutun pikin and 68 oda men. Na Hosah and Obed-Edom dey guide di gate.
1CH 16:39 Na Priest Zadok and di oda priests dey serve for God house for Gibeon.
1CH 16:40 Evry morning and evening, dem dey offa burnt sakrifice for di altar, just as dem rite am for God Law Book.
1CH 16:41 Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.”
1CH 16:42 Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.
1CH 16:43 Den evribody go back to en house and David go en house too go bless en family.
1CH 17:1 Wen King David don dey stay en palis, e kon tell Profet Natan, “I dey stay for palis wey dem build with cedar wood, but God Kovenant Box dey for tent!”
1CH 17:2 Natan ansa, “Make yu do wetin dey yor mind, bikos God dey with yu.”
1CH 17:3 Dat nite, God kon tell Profet Natan,
1CH 17:4 “Go tell David my savant sey, ‘Dis na wetin God dey tok: “Make yu nor build house for mi.
1CH 17:5 Bikos since di time wen I take Israel pipol komot from Egypt kon rish naw, I neva stay for any house. Na difren tent I dey stay for evriwhere.
1CH 17:6 Even as I travel with Israel pipol rish, I neva tell any leader wey I put before sey, ‘Wetin make yu neva build temple for mi with cedar wood!’ ” ’
1CH 17:7 So, make yu tell David my savant sey, mi wey bi di Oga God sey, ‘I take yu from where yu dey guide sheep kon make yu lead my pipol, Israel.
1CH 17:8 I dey follow yu go anywhere wey yu dey go kon let yu win all yor enemies. I go make yu dey popula like all di strong men for dis eart.
1CH 17:9 I don choose one place for my pipol, Israel and I don put dem for where dem go stay and nobody go opress dem again as dem dey do dem before-before
1CH 17:10 wen I choose pipol to dey judge dem. I go distroy all yor enemies.’ I pray sey, ‘Mi di Oga yor God go give yu many shidren wey go bi kings.
1CH 17:11 Wen time don rish for yu to die, I go make one among yor pikin, king kon make en kingdom strong.
1CH 17:12 Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom dey forever.
1CH 17:13 I go bi en papa and e go bi my pikin. I go always support am and I nor go leave am as I leave Saul wey yu take-ova from.
1CH 17:14 I go make am rule my pipol and my kingdom forever; en shidren-shidren go always dey rule.’ ”
1CH 17:15 So Profet Natan go tell David evritin wey God tell am.
1CH 17:16 So David enter Tabanako, sidan kon sey, “My Oga God! Na who bi mi and my family wey Yu dey do all dis tins for?
1CH 17:17 Yu even do di ones wey big pass dis ones! Even my grand-grand shidren wey dem neva born, Yu don promise dem many tins! My Oga God! Why Yu dey trit mi like one big man?
1CH 17:18 Wetin I won tell Yu again? Even doh Yu know mi well-well, Yu still dey respet mi wey bi yor savant.
1CH 17:19 Yu dey do all dis tins for mi yor savant, bikos na so Yu wont am. Yu don show mi how Yu big rish.
1CH 17:20 My Oga God! Nobody bi like Yu! Wi know sey na only Yu bi God.
1CH 17:21 No kountry for dis world bi like Israel pipol wey Yu save from doz wey opress dem kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, don make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt kon drive oda pipol komot from di land for dem.
1CH 17:22 Yu don turn Israel to yor pipol forever and na Yu wey bi God, bi dia God.
1CH 17:23 Naw, my Oga God, make Yu do wetin Yu promise my shidren-shidren! Make Yu do wetin Yu sey Yu go do.
1CH 17:24 Dem go know yor name, den pipol go always dey sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always keep my kingdom.
1CH 17:25 My Oga God, I dey pray with all my heart, bikos Yu don show and tell yor savant sey, ‘I go make yor shidren-shidren rule forever.’
1CH 17:26 My Oga God! Yu bi God and Yu don promise mi all dis wonderful tins.
1CH 17:27 And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”
1CH 18:1 Leta, David attack and win Filistia pipol again kon take Gat town with all en village.
1CH 18:2 E still win Moab pipol kon bigin rule and kollect tax from dem.
1CH 18:3 Afta, David attack King Hadadeza for one Siria land for Zobah near Hamat aria. King Hadadeza bi won take-ova di aria for Eufrates river side.
1CH 18:4 David seize Hadadeza 1,000 shariot, 7,000 men wey dey ride horse and 20,000 sojas wey dey waka with leg. David keep many horse for war kon break di rest ones leg.
1CH 18:5 Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.
1CH 18:6 Den David set soja kamp for dia aria kon dey rule and kollect tax from dem. God give David viktory for evriwhere.
1CH 18:7 David karry all di gold shield wey Hadadeza sojas take dey guide diasef for war, go Jerusalem.
1CH 18:8 E still take many bronze from Tibhat and Kun where Hadadeza for dey rule. (Na Solomon use all dis bronze take build tank, kolumns and oda bronze tins for di temple.)
1CH 18:9 Wen King Toi for Hamat hear sey David don win and kollect all Hadadeza sojas,
1CH 18:10 e send en pikin, Joram go greet David, bikos e win King Hadadeza. (King Toi don fight with King Hadadeza well-well before, but e nor fit win am.) Joram karry gold, silva and bronze follow body go.
1CH 18:11 King David dedikate dis tins to God with di gold and silva wey e win from Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol.
1CH 18:12 Abishai, wey en mama na Zeruaya, kill 18,000 Edom men for Salt Valley.
1CH 18:13 E put guards for Edom. Na King David dey rule all di pipol for der and God make David win all en war.
1CH 18:14 David rule Israel land kon make sure sey dem dey trit en pipol well.
1CH 18:15 Abishai wey bi Joab broda, naim bi di sojas oga and na Jehoshafat wey Ahilud born, dey keep rekord.
1CH 18:16 Ahitub pikin Zadok and Ahimelek wey Abiatar born, na dem bi priests, while Shavsha kon bi seketry for di kourt.
1CH 18:17 Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim dey lead David bodyguards and David sons na shiefs ofisas too.
1CH 19:1 Leta, King Nahash for Ammon die and en pikin Hanun kon take-ova from am.
1CH 19:2 King David sey, “I must go pay respet and make friend with King Hanun, just as King Nahash wey bi en papa, do give mi.” So David send messenjas go tell am sorry for en papa wey die. Wen David messenjas rish King Hanun palis for Ammon,
1CH 19:3 doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na, bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kon tell yu sorry? Wi know sey e send dem kom look di land, so dat leta, e go kom fight and win us!”
1CH 19:4 So King Hanun hold David messenjas, kut dia bear-bear and di klot for dia yansh side kon send dem go back.
1CH 19:5 Shame nor let dem go house back. Wen King David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko until dia hair grow again.
1CH 19:6 Wen King Hanun and Ammon pipol know sey dem don make David dia enemy, dem kon use about 75,000 pound for silva take go hire men from Aram Naharaim, Aram Maaka and Zobah.
1CH 19:7 Di 32,000 shariot wey dem hire and Maaka sojas kon kamp near Medeba. All Ammon pipol ready kom from dia town to fight.
1CH 19:8 Wen David hear wetin happen, e kon send Joab with all en sojas go.
1CH 19:9 Ammon pipol mash go pozishon for di side wey dem take dey enter Rabbah wey bi dia kapital town and all di kings wey kom help dem, dey for di open field.
1CH 19:10 Joab si sey dia enemy sojas go attack dem from both front and back, so e choose di strong-strong sojas for Israel kon make dem face Aramean pipol.
1CH 19:11 E kon sey make en broda, Abishai, dey kommand di oda sojas and dem kon face Ammon pipol.
1CH 19:12 Joab tell Abishai, “If yu si sey Aramean pipol dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon pipol dey opress yu, I go kom help yu.
1CH 19:13 Make yor heart dey strong! Make wi fight for awa pipol and God town and make God do wetin dey en mind.”
1CH 19:14 Wen Joab with en pipol attack, Aramean pipol kon bigin run.
1CH 19:15 Wen Ammon pipol si Aramean pipol dey run, dem too kon start to run from Abishai go inside dia town. Den Joab and en sojas kon go back to Jerusalem.
1CH 19:16 Wen Aramean pipol si sey Israel pipol don win dem, dem kon send for more men from di east side for Eufrates river and na Shobak wey dey kommand Hadadeza soja for Zobah, bi dia kommander.
1CH 19:17 Wen David hear am, e gada Israel sojas, cross Jordan River kon face Aramean pipol and dem kon start to fight.
1CH 19:18 Israel pipol kon porshu Aramean sojas go back. David with en men kill 7,000 shariot drivers and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey bi Aramean sojas kommander.
1CH 19:19 Wen di kings wey dey respet King Hadadeza si sey Israel pipol don win dem well-well, dem kon go make peace and bigin obey King David. So Aramean pipol nor gri kon help Ammon pipol again.
1CH 20:1 Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town.
1CH 20:2 Ammon pipol juju wear one gold crown for en head wey heavy rish 75 pounds and jewel dey inside am, so David kollect am put for en own crown. E still karry many tins komot from di town.
1CH 20:3 E karry di town pipol kon make dem work with saw, iron hoe and axe. Na so e do with di odas for all di towns for Ammon. Den en and en men, go back to Jerusalem.
1CH 20:4 Afta, Israel pipol kon fight again with Filistia pipol for Geza. For dis time, Sibbekai from Hushah kill one giant wey dem dey koll Sippai and dem kon win Filistia pipol.
1CH 20:5 Dem still fight with Filistia pipol and Elhanan wey Jair born, kill Lahmi wey bi Goliat broda from Gat wey e spear tick rish di bar wey dem take dey weave.
1CH 20:6 Anoda fight happen for Gat, where e get one giant wey get six fingers for en hand and six toe for en leg. Na di giants family for Gat, e from kom.
1CH 20:7 E dey trobol Israel pipol, but na Jonatan wey David broda, Shimea born, kill-am.
1CH 20:8 All dis men na giant, Rafa shidren-shidren for Gat and na David with en men, kill dem.
1CH 21:1 Naw, Devil won bring trobol kom meet Israel pipol, so e kon make David kount di pipol.
1CH 21:2 David orda Joab and di oda ofisas sey, “Make una go round Israel from one end to di oda for di kountry kon kount all di pipol, bikos I won know how dem many rish.”
1CH 21:3 Joab ansa, “God go make Israel pipol many pass di way dem bi naw! But my oga! All di pipol na yor own, wetin make yu won do dis tin kon put di whole kountry for wahala?”
1CH 21:4 But David make Joab obey en kommand. So Joab travel round Israel kon kom back to Jerusalem.
1CH 21:5 E tell David, “Di men wey fit bi sojas for Israel na 1,100,000 and for Judah, dem bi 470,000.”
1CH 21:6 Bikos Joab nor won bin do wetin di king kommand am, e nor kon kount Levi and Benjamin tribe.
1CH 21:7 God vex well-well for wetin happen, so E kon ponish Israel.
1CH 21:8 David tell God, “Na big sin I don kommit so, bikos I kount di pipol. Abeg make Yu forgive mi, bikos of dis foolish tin wey I do.”
1CH 21:9 Den God tell Profet Gad,
1CH 21:10 “Go tell David sey I dey gi-am three tins to choose from and na any one wey e choose, I go do.”
1CH 21:11 So Profet Gad go meet David kon tell am wetin God tok, den e ask am, “Na wish one yu wont make God do?
1CH 21:12 “Three years wey food nor go too dey; or three monts wey una go dey run from una enemy sojas; or three days wey God go attack una with sickness and en angel go bring deat kom dis land? Na wish one yu wont make I tell God?”
1CH 21:13 David ansa, “My kase bad well-well, but I nor wont make men ponish mi. Instead make only God ponish mi, bikos E dey sorry for pesin.”
1CH 21:14 So God send sickness kom Israel and 70,000 pipol die.
1CH 21:15 God send angel go distroy Jerusalem. Leta, E shange en mind kon tell di angel, “Make yu stop! Di one wey yu do, don rish!” Di angel stand near Araunah wey kom from Jebus, farm.
1CH 21:16 David si as di angel stand for di centre; hold en swod as e bin won distroy Jerusalem finish.
1CH 21:17 So David pray, “My Oga God, na mi do wrong; na mi sey make dem kount pipol. Wetin all dis poor pipol do? Abeg, make Yu leave dis pipol kon ponish mi and my family.”
1CH 21:18 Den God angel kon tell Profet Gad, “Kommand David make e go Araunah farm go build altar for God for der.”
1CH 21:19 So David obey God kommand and e go build altar for der, just as Profet Gad tell am.
1CH 21:20 For di farm, as Araunah and en four shidren dey plant wheat, dem kon si di angel, den all of dem run go hide.
1CH 21:21 As Araunah si David dey kom, e bow face groun.
1CH 21:22 David kon tell am, “Make yu sell yor farm give mi, I won build altar put for God, so dat dis sickness go stop. I go give yu di money wey yu wont for am.”
1CH 21:23 Araunah ansa, “My king! Make yu take am do anytin wey yu wont. Yu still fit take dis animal kon burn am for di altar, den use dis board take do di fire; even wheat dey here for ofrin. I dey give all of dem to yu.”
1CH 21:24 But David ansa, “No! I go pay yu for evritin, I nor go fit give wetin bi yor own to God as ofrin. I nor fit give God sometin wey I nor sweat or pay for.”
1CH 21:25 So David pay Araunah six hundred gold koins for di farm.
1CH 21:26 E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.
1CH 21:27 God tell di angel make e remove en swod and e obey.
1CH 21:28 David si sey God don ansa en prayer, so e kon still offa sakrifice for di altar wey dey Araunah farm.
1CH 21:29 As all dis tins dey happen, di tent wey Moses build for desert and di altar where dem for dey burnt sakrifice put, still dey where dem for dey woship for Gibeon.
1CH 21:30 But David nor fit go woship God for der, bikos e dey fear God angel and en swod.
1CH 22:1 So David sey, “Na dis place di Oga awa God Temple go dey. Na for here Israel pipol go for dey burn dia ofrin give God.”
1CH 22:2 King David kon give orda sey make all di strenjas for Israel gada kom work. E sey make some make block wey dem go use take build di temple.
1CH 22:3 E give dem many iron to take make nail with wood wey dem go take make di gate. E still give dem many bronze wey nobody fit measure.
1CH 22:4 Tyre and Sidon pipol bring many cedar wood kom gi-am.
1CH 22:5 David kon tink and sey, “Di temple wey Solomon wey bi my pikin go build, must fine well-well, but e still yong naw and e nor know anytin, so I must prepare tins for am.” So David gada many tins keep for Solomon before e die.
1CH 22:6 E send message go koll Solomon kon tell am make e build di Oga wey bi Israel God Temple.
1CH 22:7 David tell Solomon, “My pikin, I really won build temple take honor di Oga wey bi my God.
1CH 22:8 But E tell mi sey I don fight many war and kill too many pipol. And bikos of di pipol wey I don kill, I nor go fit build temple for am.
1CH 22:9 But E promise mi sey, ‘Yor pikin go rule with peace, bikos I go make all en enemies love am. Di pikin name go bi Solomon, bikos for en time, I go give Israel pipol peace kon guide dem.
1CH 22:10 E go build temple for mi. I go bi en papa and e go bi my pikin. En kingdom for Israel, go dey forever and ever.’ ”
1CH 22:11 David still sey, “Naw my pikin, make di Oga awa God dey with yu and make E help yu build en temple, just as E promise.
1CH 22:12 Make di Oga wey bi yor God give yu wisdom to take rule Israel, just as E tok.
1CH 22:13 If yu obey all di law wey God give Moses for Israel, yu go prosper. Make yor heart strong and make yu nor fear at-all.
1CH 22:14 “But for di temple, I don use my pawa gada almost 4,000 tons for gold and 40,000 tons for silva wey dem go take build am. Dem still dey bring many bronze and iron kom. I don still keep wood and stone wey yu go use, but yu go still nid more.
1CH 22:15 Yu get many men wey dey work for yu; men wey go make stones and yu still get karpenters too. Yu still get enough men wey go work
1CH 22:16 with gold, silva, bronze and iron. Naw, make yu start di work and make God dey with yu.”
1CH 22:17 David kommand all di leaders for Israel make dem help Solomon.
1CH 22:18 E tell dem, “Di Oga wey bi una God dey with una and E don give una peace for evry side. E make mi win all di pipol wey dey stay dis land and dem dey under una and God.
1CH 22:19 Naw, make una serve God with all una heart and soul. Make una start to build di temple, so dat una go fit put di Kovenant Box and all di holy tins wey dem take dey serve God, for inside.”
1CH 23:1 Wen David don old well-well, e kon make en pikin Solomon, king for Israel.
1CH 23:2 David gada Israel leaders, di priests and Levi pipol togeda
1CH 23:3 kon kount all di men wey kom from Levi tribe wey don rish or pass thirty years and all of dem na, 38,000.
1CH 23:4 Di king choose 24,000 wey go do di temple work; 6,000 wey go dey rite and judge kase;
1CH 23:5 4,000 wey go dey guide and anoda 4,000 wey go dey praiz God with di music instrument wey di king make.
1CH 23:6 David divide Levi pipol into three groups, just as dem take kom from Gershon, Kohat and Merari family.
1CH 23:7 Gershon born two sons: Ladan and Shimei.
1CH 23:8 Ladan three son na: Jehiel, Zetam and Joel.
1CH 23:9 Shimei three sons na: Shelomot, Haziel and Haran. Na dem dey lead Ladan family.
1CH 23:10 Shimei still born: Jahat, Ziza, Jeush and Beraya.
1CH 23:11 Na Jahat dey lead di family sekond to Ziza. Jeush and Beraya nor born many sons, so dem kount dem as one family.
1CH 23:12 Kohat born four sons: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
1CH 23:13 Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.
1CH 23:14 But Moses wey bi God savant, dem rite en shidren-shidren name join Levi pipol.
1CH 23:15 Moses born two sons: Gershom and Elieza.
1CH 23:16 Na Shebuel bi Gershom first son.
1CH 23:17 Elieza born only Rehabaya, but Rehabaya born many shidren.
1CH 23:18 Na Kohat sekond pikin, Izhar born Shelomit.
1CH 23:19 Hebron four sons na: Jeraya, Amaraya, Jahaziel and Jekameam.
1CH 23:20 Uzziel sons na: Mikah and Isshaya.
1CH 23:21 Merari sons na: Mahli and Mushi. Mahli sons na: Eleazar and Kish.
1CH 23:22 But Eleazar nor get boy pikin before e die, na only girls e born. En girl shidren marry Kish shidren wey bi dia kousin.
1CH 23:23 Mushi born three sons: Mahli, Eda and Jerimot.
1CH 23:24 Na Levi shidren-shidren bi dis, just as dem rite dia name for dia difren family. Doz wey don rish twenty years for Levi family, still follow dem work for God Temple.
1CH 23:25 Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.
1CH 23:26 So, Levi pipol nor nid to dey karry di tent wey God dey and all di tins wey dem take dey woship am, again.”
1CH 23:27 Just as David kommand, dem kon kount Levi pipol wey don rish and pass twenty years.
1CH 23:28 Dia work na to help Aaron shidren-shidren as dem dey serve for God Temple. Na dem dey kare for di kourtyard; di rooms; to dey klean di holy tins and any oda tin wey koncern God Temple.
1CH 23:29 Na dem still dey kare for di bread wey dey der; di ofrin flour; di bread wey nor get yist; to dey mix dem and all di tins wey dem dey measure.
1CH 23:30 Dem still dey stand for one special place evry morning and evening dey offa tanks and praiz to God,
1CH 23:31 both for di time wen dem burn sakrifice as ofrin to God on Sabat Day and for New Moon Feast. E get di nomba of pipol wey must serve God evritime, just as dem rite am for di law.
1CH 23:32 Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.
1CH 24:1 Dis na how dem take divide Aaron shidren-shidren: Aaron sons na: Nadab, Abihu, Eleazar and Itama.
1CH 24:2 Nadab and Abihu die before dia papa die and dem nor born pikin, so dia brodas, Eleazar and Itama kon bi priest.
1CH 24:3 Na King David, Zadok (wey kom from Eleazar Family) and Ahimelek (wey kom Itama family), group Aaron shidren-shidren akordin to di work wey dem go do.
1CH 24:4 Eleazar shidren-shidren get more leaders pass Itama own, so dem divide dem akordin to dia family. Eleazar get sixteen leaders, while Itama get eight.
1CH 24:5 As e bi sey di temple ofisas and spiritual leaders dey among Eleazar and Itama shidren-shidren, dem kon trow dice take divide dem.
1CH 24:6 Di seketry, Shemaya wey bi Netanel pikin from Levi tribe kon rite dia names give di king, di ofisas, Priest Zadok, Ahimelek wey bi Abiatar pikin and di leaders among di priests and Levi family. Dem choose each family with di dice wey dem trow for Eleazar and Itama.
1CH 24:7 So di twenty-four family wey dem give work na: Jehoiarib, Jedaya,
1CH 24:8 Harim, Seorim,
1CH 24:9 Malkijah, Mijamin,
1CH 24:10 Hakkoz, Abijah,
1CH 24:11 Jeshua, Shekanaya,
1CH 24:12 Eliashib, Jakim,
1CH 24:13 Huppah, Jeshebeab,
1CH 24:14 Bilgah, Imma,
1CH 24:15 Hezir, Happizzez,
1CH 24:16 Petahaya, Jehezkel,
1CH 24:17 Jakin, Gamul,
1CH 24:18 Delaaya and Mazzaya.
1CH 24:19 Dis na how dem take do dia work wen dem enter God Temple and na akordin to di rules wey dia grand-grand papa Aaron give dem, just as di Oga wey bi Israel God, kommand am.
1CH 24:20 Levi leaders wey remain na: Shebuel from Amram family; Jehdeaya from Shebuel family.
1CH 24:21 Isshaya from Rehabaya family;
1CH 24:22 Shelomit from Izhar family; Jahat from Shelomit family.
1CH 24:23 From Hebron family na Jeraya, Amaraya, Jahaziel and Jekameam.
1CH 24:24 Mikah from Uzziel family while from Mikah family na Shamir
1CH 24:25 with Isshaya wey bi Mikah broda. Zekaraya from Isshaya family.
1CH 24:26 Mahli and Mushi from Merari family. Beno from Jaazaya family.
1CH 24:27 From Merari family thru Jaazaya di leaders na Beno, Shoham, Zakkur and Ibri.
1CH 24:28 From Mahli family na Eleazar bi leader, doh e nor born boy pikin.
1CH 24:29 From Kish family, na Jerahmeel bi di leader.
1CH 24:30 From Mushi family, di leaders na Mahli, Eda and Jerimot. All dis na leaders for Levi family.
1CH 24:31 Just like di leaders for Aaron family, dem divide dia work give dem with dice wey dem trow without sey dem use age or rank. King David, Zadok, Ahimelek, di priests and di leaders for Levi tribe dey der and dem do evritin for dia front.
1CH 25:1 King David and di ofisas pick some of Asaf, Heman and Jedutun shidren to profesai as dem dey play instrument and cymbals. Dis na di men wey dem choose:
1CH 25:2 From Asaf sons: Zakkur, Josef, Netanaya and Asarelah. Asaf wey dey profesai for di king, na-im dey lead dem.
1CH 25:3 From Jedutun sons: Gedalaya, Zeri, Jeshaaya, Shimei, Hashabaya and Mattitaya. Dia papa wey dey profesai wen dem dey praiz God, na-im dey lead dem.
1CH 25:4 From Heman sons: Bukkaya, Matanaya, Uzziel, Shebuel, Jerimot, Hananaya, Hanani, Eliatah, Giddalti, Romamti-Ezer, Joshbekashah, Malloti, Hotir and Mahaziot.
1CH 25:5 All dis na di king profet wey bi Heman shidren. God gi-am fourteen sons and three dotas, just as E promise am sey e go dey great.
1CH 25:6 Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman.
1CH 25:7 Dem train dem and dia rilashons so dat dem go fit play music well for God and dem bi 288.
1CH 25:8 Dem dey trow dice to take know di work wey dem go do, weda yu old or yong, weda yu sabi di work or just dey start am.
1CH 25:9 Di first dice wey dem trow na for Josef wey bi Asaf pikin and twelf of en sons and rilashons. Di next one na Gedalaya and twelf of en sons and rilashons,
1CH 25:10 before Zakkur and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:11 Next pesin na Izri and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:12 Den Netanaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:13 Before Bukkaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:14 Di next na Jesharelah and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:15 Before Jeshaaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:16 Matanaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:17 Shimei and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:18 Azarel and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:19 Hashabaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:20 Shubael and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:21 Mattitaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:22 Jerimot and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:23 Hananaya and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:24 Joshbekashah and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:25 Hanani and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:26 Malloti and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:27 Eliatah and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:28 Hotir and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:29 Giddalti and twelf of en sons and rilashons.
1CH 25:30 Mahaziot and di twenty fourt dice, na for
1CH 25:31 Romamti-Ezer and twelf of en sons and rilashons.
1CH 26:1 Doz wey dey guide di temple, na dia names bi dis: From Korah tribe: Meshelemaya wey Kore born and e kom from Asaf family.
1CH 26:2 Meshelemaya sons na: Zekaraya wey bi senior, before Jediael, Zebadaya, Jatniel,
1CH 26:3 Elam, Jehohanan and Eliehoenai.
1CH 26:4 Obed-Edom sons na: Shemaya wey bi senior, before Jehozabad, Joah, Sakar, Netanel,
1CH 26:5 Ammiel, Issakar and Peulletai. (True-true, God bless Obed-Edom.)
1CH 26:6 Obed-Edom first pikin Shemaya still born sons wey bi leaders and pipol dey respet dem well-well.
1CH 26:7 Shemaya sons na: Otni, Refael, Obed, Elzabad. En relashon na Elihu and Semakaya and pipol dey respet dem too.
1CH 26:8 All dis na Obed-Edom family. Pipol dey respet dem well-well, bikos dem sabi do dia work. Dem bi sixty-two wey rilate to Obed-Edom.
1CH 26:9 Meshelemaya get eighteen sons and rilashons wey pipol dey respet well-well.
1CH 26:10 Hosah wey kom from Merari family born four boy and dem bi: Shimri (en papa make am di first-born, even doh nor bi en dem first-born),
1CH 26:11 di sekond na Hilkaya, before Tebalaya and Zekaraya. Na thirteen pipol for Hosah family bi guide for di temple.
1CH 26:12 Dem divide di temple guards, just as dia family bi and dem give dem work for di temple, just as dem give di oda Levi pipol.
1CH 26:13 Di pipol from each family trow dice, both yong and old, just to know di work wey dem go do.
1CH 26:14 Di dice for di east gate na for Shelemaya and en pikin, den Zekaraya wey dey give betta advise kon take di nort gate.
1CH 26:15 Dem give Obed-Edom di gate for sout sey make en sons dey guide di store room.
1CH 26:16 Na Shuppim and Hosah dem give di west gate and Shalleket gate wey dey di road for up. Di guards dey shange duty among demsef.
1CH 26:17 Evriday, six guards dey-dey for di east, four for nort and four for sout. But na four guards dey-dey di store room, two-two for one side.
1CH 26:18 Na four guards dey di kourt for di west, while two dey inside di kourt.
1CH 26:19 Dis na how dem take divide di guards wey bi Korah and Merari family.
1CH 26:20 Oda Levi pipol dey guide di precious tins wey dey di temple and di store room wey dem put di tins wey dem dedikate give God.
1CH 26:21 From Ladan family wey kom from Gershon tribe, na Jehiel bi dia leader.
1CH 26:22 Na Jehiel sons, Zetam and Joel dey kare for di store room for di temple.
1CH 26:23 Di leader wey kom from Amram, Izhar, Hebron and Uzziel family na:
1CH 26:24 Shebuel wey Moses pikin Gershom born, na-im dey supavise di store room.
1CH 26:25 En relashon thru Elieza na: Rehabaya, Jeshaaya, Joram, Zikri and Shelomit.
1CH 26:26 Evry gift wey King David, di leaders, doz wey dey lead tazon and hundred sojas dedikate give God, na Shelomit and en relashon dey guide dem for di temple.
1CH 26:27 Dem don dedikate some of di tins wey dem karry from war give God for di temple.
1CH 26:28 Evritin wey Profet Samuel, Kish pikin Saul, Ner pikin Abner and Joab pikin Zeruaya dedikate give God for di temple, na Shelomit and en rilashons dey guide dem.
1CH 26:29 But for Izhar family, dem give Kenanaya and en shidren work outside di temple, as ofisas and judge for Israel.
1CH 26:30 As for Hebron family: Hashabaya and en relashon wey bi 1,700 men wey pipol dey respet, na dem dey work for di west side for Jordan River for Israel. Dem do God work and wetin di king wont.
1CH 26:31 For Hebron family, na Jeraya bi leader just as dem rite am. For di forty years wen King David dey rule, dem shek where dem rite am put kon si sey, dis men na pipol wey pipol dey respet for Jazer wey dey Gilead.
1CH 26:32 King David choose 2,700 men from Jeriaya relashon wey pipol dey respet well-well kon sey make dem dey lead Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe. Na dem dey judge any matter wey koncern God and di king.
1CH 27:1 Dis na di list of leaders for Israel family and tribe with ofisas wey dey kommand sojas and all of dem get dia work for di kingdom. Dem sey make each group dey serve one mont for evry year and na 24,000 men dey each group.
1CH 27:2 Dis na di pipol wey dey kommand each group: di first group for di first mont na: Jashobeam wey bi Zabdiel pikin and dem bi 24,000 men.
1CH 27:3 E kom from Perez family and na-im dey for di first mont.
1CH 27:4 For di sekond mont na: Dodai wey kom from Ahohi family (Na Miklot bi en main offisa) and dem bi 24,000 men.
1CH 27:5 Di third mont na: Benaya wey bi Priest Jehoiada pikin, dey lead dem and dem bi 24,000 men.
1CH 27:6 Na Benaya bi di leader for di “Thirty.” Na en pikin, Amizabad bi en main offisa.
1CH 27:7 For di fourt mont: Asahel wey bi Joab broda, na-im dey lead dis group. (En pikin, Zebadaya kon take-ova from am) and dem bi 24,000 men.
1CH 27:8 Di fift mont na: Shamhut wey kom from Izhar family na-im dey lead am and dem bi 24,000 men.
1CH 27:9 Di sixt mont na: Ira wey Ikkesh wey kom from Tekoa, born and dem bi 24,000 men.
1CH 27:10 Di sevent mont na: Helez wey kom from Efraim tribe for Pelon and dem bi 24,000 men.
1CH 27:11 Di eight mont na: Sibbekai for Hushah and na from Zera family for Judah tribe, e from kom and dem bi 24,000 men.
1CH 27:12 Di ninet mont na: Abiezer from Anatot wey dey Benjamin tribe and dem bi 24,000 men.
1CH 27:13 Di tent mont na: Maharai from Netofat (na Zera family e from kom) and dem bi 24,000 men.
1CH 27:14 Di elevent mont na: Benaya from Piraton wey dey Efraim tribe and dem bi 24,000 men.
1CH 27:15 And di twelft mont na: Heldai from Netofat (e kom from Otniel family) and dem bi 24,000 men.
1CH 27:16 Di ofisas for Israel tribe na: Zikri pikin Elieza and e dey lead Reuben tribe. Shefataya wey Maaka born, dey lead Simeon tribe.
1CH 27:17 Na Kemuel pikin Hashabaya dey lead Levi pipol, but na Zadok dey lead Aaron shidren-shidren.
1CH 27:18 Na King David broda Elihu dey lead Judah tribe, while Omri wey Mikael born dey lead Issakar tribe.
1CH 27:19 Na Obadaya pikin Ishmaya dey lead Zebulun tribe, while Jerimot wey Azriel born dey lead Naftali tribe.
1CH 27:20 Hoshea wey Azazaya born, na-im dey lead Efraim tribe, while Joel wey bi Pedaaya pikin, dey lead West Manasseh.
1CH 27:21 Iddo wey bi Zekaraya pikin dey lead East Manasseh for Gilead; Jaasiel wey Abner born dey lead Benjamin tribe,
1CH 27:22 while Jeroham pikin, Azarel dey lead Dan tribe.
1CH 27:23 Wen David sey make dem kount di pipol, e sey make dem nor kount pipol wey neva pass twenty years, bikos God promise sey E go make Israel pipol plenty like di stars wey dey di sky.
1CH 27:24 Joab wey en mama na Zeruaya kon bigin kount di pipol, but e nor komplete am. God kon ponish Israel for wetin dem do, so dem nor fit rite di real nomba for King David own book.
1CH 27:25 Dis na di pipol wey keep di king propaty for en palis: For di royal store room, Azmavet wey Adiel born, dey der. Na Jonatan wey Uzzaya born, dey di local store room. To dey do farm work na:
1CH 27:26 Ezri wey Kelub born, na-im dey der.
1CH 27:27 Na Shimei from Ramat dey di vineyard, while Zabdi from Shefam, dey di wine store.
1CH 27:28 Na Baal-Hanan from Geder dey keep di olive and sikamore trees (wey dey di west land for under di hills). While Joash dey keep di olive oil.
1CH 27:29 Shitrai wey kom from Sharon, na-im dey keep di melu dem for where dem for dey chop grass for Sharon, while Shafat wey Adlai born, dey keep di animals wey dey di valley.
1CH 27:30 Na Obil wey kom from Ishmael tribe, dey keep di kamel; Jehdeaya from Meronot dey keep di donkeys, while
1CH 27:31 Jaziz wey kom from Hagrit, dey keep di sheep.
1CH 27:32 Jonatan wey bi David papa broda na betta advise and e know wetin e dey tok. Na en and Hakmoni pikin, Jehiel dey tish di king sons.
1CH 27:33 Na Ahitofel dey advise di king, while Hushai from Ark, na di king very good friend.
1CH 27:34 Jehoiada wey Abiatar born give Benaya, na-im kon take-ova from Ahitofel. Na Joab bi di whole sojas oga.
1CH 28:1 King David kommand and gada all di offisa for Jerusalem. So all di ofisas for di tribe wey dey do di kingdom work; di family leaders; doz wey dey look di propaty and di animals wey di king and en shidren get; all di ofisas for di palis; di sojas oga and all di men wey pipol dey respet kon gada for Jerusalem.
1CH 28:2 David stand for dia front kon sey, “My kountry pipol, make una listin to mi. I bin won build betta house for God Kovenant Box, where God go stay. I don prepare tins to take build betta temple for God.
1CH 28:3 But God nor gri make I do am, bikos I don fight and kill many pipol for war.
1CH 28:4 “So di Oga wey bi Israel God don choose mi and my shidren-shidren as king for Israel forever. E sey make Judah tribe dey bring doz wey go lead and na from Judah, E from choose my papa family. And from di family, E kon choose mi as king for Israel.
1CH 28:5 E give mi many sons and na Solomon E choose from all of dem, make e rule God pipol for Israel.
1CH 28:6 God tell mi, ‘Na yor pikin, Solomon, go build my temple. I don choose am as my pikin and I go bi en papa.
1CH 28:7 If e kontinue to obey my laws and kommand as e dey do naw, I go make en kingdom last forever.’
1CH 28:8 “So naw, my pipol, for awa God present and for all Israel wey bi God pipol front, I sey make una obey evritin wey God kommand us, so dat una go kontinue to stay dis betta land kon leave am for una shidren-shidren forever.”
1CH 28:9 Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.
1CH 28:10 Yu must know sey God don choose yu to build en temple. Naw, make yu use all yor heart take build am.”
1CH 28:11 David kon give Solomon di plans wey e go take build di temple, di store room, all di oda rooms and di place wey holy pass, where God for dey forgive pipol dia sins.
1CH 28:12 E still gi-am di plan, just as e get am for mind to build di kourtyard and di rooms wey round dem; di store room wey dem go put di temple tins and di gifts wey dem dedikate give God.
1CH 28:13 David gi-am di plan wey di priest and Levi pipol go take dey know and do dia work for di temple and how to keep all di temple plate and spoons.
1CH 28:14 E still tell am about di amount of silva and gold wey e go use take make di spoon, pot, plates,
1CH 28:15 di lamp, di lampstand,
1CH 28:16 di silva tabol and di gold tabols wey dem go put di bread wey dem go offa give God.
1CH 28:17 E tell am how mush e go take buy di pure gold take make fork, plate, jug,
1CH 28:18 di altar where dem go for dey burn incense and di shariot wey go karry di creature wey dia feadas kover di Kovenant Box.
1CH 28:19 King David sey, “All dis tins dey for di plan wey dem rite, just as God kommand mi.”
1CH 28:20 David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.
1CH 28:21 Dem don give di priest and Levi pipol, di work wey dem go do for di temple. Doz wey sabi work dey ready to help yu and all di pipol and dia leaders go obey yor kommand.”
1CH 29:1 King David tell all di pipol, “Na Solomon my pikin God choose, but e still dey yong and e neva sabi many tins. Di work wey dem won do dey hard, bikos dis nor bi palis for man, but na temple for di Oga awa God.
1CH 29:2 I don try to prepare silva, gold, bronze, iron, timba, stones wey dear, jem stones to take make di floor and many marbols to take build di temple.
1CH 29:3 Even with all dis tins wey I don gada, I still give my silva and gold, bikos of di love wey I get for God Temple.
1CH 29:4 I don give more dan 112 tons for di gold wey fine pass and 262 tons for silva wey dey pure, so dat dem go take am take dekorate di temple wall
1CH 29:5 and all di tins wey una go make. Naw, who go like give God ofrin from en heart?”
1CH 29:6 Den all doz wey dey lead dia family, di tribe ofisas, di sojas oga dem and doz wey dey work for di temple kon sey dem go give
1CH 29:7 dis tins for di temple work: about 188 tons for gold; 10,000 gold koin, 375 tons for silva; 675 tons for bronze and 3,750 tons for iron.
1CH 29:8 Doz wey get stones wey dear, bring dem kom where dem put di tins wey dem won use take build di temple and na Jahiel wey kom from Gershon family, bi dia leader.
1CH 29:9 Di pipol use dia mind take give and dem happy sey dem don give many tins to God. So David kon dey happy too.
1CH 29:10 For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!
1CH 29:11 Yu dey great and get pawa; Yu get glory, honor and respet. Evritin for heaven and eart, na yor own and dis na yor kingdom. Wi dey praiz Yu pass evritin for dis world.
1CH 29:12 Na from Yu money and propaty from dey kom. Na yor strent and pawa Yu take dey rule evritin and Yu fit make anybody big and strong.
1CH 29:13 Awa God, wi tank and praiz yor name wey get pawa.
1CH 29:14 “But who mi and my pipol bi? Wi nor really fit give Yu anytin, bikos na Yu get evritin and wi dey give Yu wetin Yu first give us.
1CH 29:15 Awa Oga God! Yu know sey wi dey pass thru dis world like strenjas, just as awa grand-grand papa dem do. Awa days bi like shadow wey dey fade and wi nor fit run from deat.
1CH 29:16 Awa Oga God, wi don bring all dis tins togeda to take build temple take honor yor name, but all of dem kom from Yu and dem bi yor own.
1CH 29:17 I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
1CH 29:18 God wey bi awa grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob God, make yor pipol always dey ready to obey Yu forever, so dat Yu go always make dem dey faithful to Yu.
1CH 29:19 Make Yu give Solomon my pikin di heart to take obey evritin wey Yu kommand, about how dem go take build di temple, wey I don gada tins for.”
1CH 29:20 Den David kommand en pipol, “Make una praiz di Oga wey bi una God!” And all di pipol praiz di Oga wey bi dia papa God kon bow honor en and di king.
1CH 29:21 Di next day, dem kon dedikate and sakrifice some animals to God, den dem give dem to di pipol make dem chop. Dem still sakrifice 1,000 rams, bulls and lamb for di altar kon still bring wine as ofrin.
1CH 29:22 So dem chop and drink as dem dey happy for God present. Den dem kon dey shaut, “Na Solomon bi king.” Den, dem anoint am with God name as dia ruler kon make Zadok dia priest.
1CH 29:23 So Solomon take-ova from en papa David for di throne wey God don bless. Solomon prosper well-well and all di kountries dey obey am.
1CH 29:24 All di ofisas, sojas and even David oda shidren kon promise sey dem go respet am as dia king.
1CH 29:25 God make all di nashons dey sopraiz for Solomon, bikos E gi-am glory wey pass any oda king wey don rule Israel before am.
1CH 29:26 David wey Jesse born rule Israel
1CH 29:27 for forty years. E rule from Hebron for seven years and e rule Jerusalem for thirty-three years.
1CH 29:28 E die wen e don old well-well. E get many propaty and evribody dey respet am. Solomon en pikin kon take-ova from am as king.
1CH 29:29 Evritin wey David do from biginnin go rish end, dem rite am both for Profet Samuel, Profet Natan and Profet Gad book.
1CH 29:30 Di book show how e get pawa rish and all di tins wey happen to en, Israel pipol and all di kingdoms wey dey near am.
2CH 1:1 David pikin, Solomon kon make en kingdom strong well-well, bikos di Oga wey bi en God dey with am and E gi-am pawa.
2CH 1:2 Solomon tok to Israel pipol, plus doz wey dey kommand difren group from hundred go rish tazon; doz wey dey judge kase and all di leaders for Israel wey bi head for dia family.
2CH 1:3 Solomon and all di pipol go woship God for Gibeon, for di altar wey God savant, Moses, build for di wildaness.
2CH 1:4 (For dis time, David don take di Kovenant Box from Kiriat-Jearim go di place wey e prepare for am for Jerusalem.
2CH 1:5 But di bronze altar wey Bezalel, Uri pikin, wey bi Hur grand-pikin make, dey for front of Tabanako. Solomon and all di pipol kon pray to God for der.)
2CH 1:6 Solomon go meet God for di bronze altar wey dey di place kon do sakrifice. E kill 1,000 animal kon burn dem as ofrin.
2CH 1:7 Dat nite, God appear to Solomon kon tell am, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu.”
2CH 1:8 Solomon ansa, “My God! Yu show sey Yu dey loyal to my papa David and Yu make mi king afta am.
2CH 1:9 Naw, my Oga God, make yor promise wey Yu make with my papa David, happen, bikos Yu don make mi king ova dis great nashon wey plenty like san-san.
2CH 1:10 My Oga God! Make Yu give mi wisdom and undastandin, so dat I go fit lead yor pipol well. Bikos without wisdom, nobody go fit rule dis yor great nashon well.”
2CH 1:11 God tell Solomon, “Yu nor ask for money, propaty and honor, or pawa to revensh yor enemies or for long life, instead yu ask for wisdom and undastandin, so dat yu go fit rule my pipol well;
2CH 1:12 naw, wisdom and undastandin, na yor own. I go still give yu money, propaty and di kind honor wey pass evry oda king wey dey before and wey go dey afta yu.”
2CH 1:13 Solomon komot from di tent for where dem for dey woship for Gibeon kon go Jerusalem, where e for rule ova Israel.
2CH 1:14 Solomon kon get many shariot. E get 1,400 shariot and en ordinary horse na 12,000. E keep dem for difren place for Jerusalem.
2CH 1:15 Di king make silva and gold plenty for Jerusalem like san-san; cedar wood many for Jerusalem like sikamore fig tree wey dey di low lands.
2CH 1:16 Solomon buy en horse dem from Egypt and Kwe and na di pipol wey dey buy and sell horse give kings, sell for am.
2CH 1:17 Dem pay 600 silva for each shariot from Egypt, plus 150 silva for ordinary horse. Dem still sell shariot and ordinary horse to all di kings for Hit and Siria.
2CH 2:1 Solomon sey make dem build one temple to take honor God and one royal palis for ensef.
2CH 2:2 Solomon get 70,000 ordinary workers and 80,000 men wey dey kut stone for di mountin, plus 3,600 men wey dey supavise di workers.
2CH 2:3 Solomon send message go meet King Hiram for Tyre sey, “Make yu kom help mi, just as yu help my papa David, wen yu gi-am cedar wood make e take build en palis.
2CH 2:4 I dey ready to build one temple to honor di Oga my God and to dedikate am gi-am. I go burn betta incense for am; offa bread and burnt sakrifice evry morning and evening and for Sabat Day too. I go do di same tin for new moon festival and evry oda tin wey di Oga my God tok. Dis na wetin Israel pipol go dey do.
2CH 2:5 I go build betta big temple, bikos awa God big and betta pass evry oda gods.
2CH 2:6 True-true! Who fit really build temple for am, since di sky and di heavens wey high pass too small for am? Who I bi to build temple for am? E go just bi where dem go for dey offa sakrifice gi-am.
2CH 2:7 So, make yu send somebody kom; pesin wey know how to work with gold, silva, bronze and iron, plus purpol, crimson and violet klot. Pesin wey fit design well-well. E go work with my men wey sabi karve tins for Jerusalem and Judah, bikos na David my papa train dem.
2CH 2:8 Make yu send cedar wood, evagreen and algum trees for Lebanon kon give mi, bikos I know sey yor savants sabi kut trees. My savants go work with yor savants,
2CH 2:9 so dat dem go fit give mi many wood make I take build betta big temple.
2CH 2:10 Si, yor savants wey go kut di wood, I go pay dem with 20,000 bag of wheat, 20,000 bag of barley, 120,000 gallon of wine and 120,000 gallon of olive oil.”
2CH 2:11 King Hiram for Tyre kon send dis leta go give Solomon: “Bikos God love en pipol, E kon make yu king.”
2CH 2:12 Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef.
2CH 2:13 Naw, I dey send Hiram kom meet yu. E sabi di work well-well;
2CH 2:14 en mama kom from Dan tribe, while en papa na from Tyre. E know how to work with gold, silva, bronze, iron, stones and wood; plus purpol, violet, white and crimson klot. E still know how to make difren design. E go work with yor men and yor papa David men.
2CH 2:15 Naw, make my oga send di wheat, barley, olive oil and wine as e promise kom give en savant;
2CH 2:16 wi go get all di wood wey yu wont from Lebanon kon arrange dem kom give yu thru Joppa Sea. So yu fit karry dem from der go Jerusalem.”
2CH 2:17 Solomon kon still kount all di men wey bi strenjas for Israel, afta en papa David kount evribody for Israel. All of dem na 153,600.
2CH 2:18 E make 70,000 of dem ordinary worker; 80,000 dey kut stones for di mountin, while 3,600 dey supavise di workers, to make sure sey di pipol komplete di work.
2CH 3:1 Solomon kon start to build God Temple for Jerusalem on-top Mount Moraya, di place where God for appear to en papa David, but na Araunah wey kom from Jebus, get der before.
2CH 3:2 Solomon don dey rule for four years wen e start to build for di sekond day for di sekond mont.
2CH 3:3 Di foundashon wey Solomon build for God Temple long rish 90 fit (akordin to as dem dey measure before) and wide rish 30 fit.
2CH 3:4 Di varanda for di main hall front na 30 fit, while di temple wide and high rish 30 fit. Solomon design inside di temple with pure gold.
2CH 3:5 E make di main hall with board wey dem make from evagreen trees; design am with fine gold kon dekorate am with palm trees and shains.
2CH 3:6 E dekorate di temple with precious stones and na from Parvaim dem from bring di gold wey e use.
2CH 3:7 E still design di house, di beams, di wall, di post and all di doors wey dey di temple and e karve tins wey bi like angel for di walls.
2CH 3:8 E make di Most Holy Place long rish 30 fit, while di temple wide and deep rish 30 fit too. E design am with fine gold wey dear rish 600 silva koin.
2CH 3:9 Di nail for di gold heavy rish 50 shekel and e still design di up with gold.
2CH 3:10 For di Most Holy Place, e make two image wey bi like angel kon design dem with gold.
2CH 3:11 If dem put di angels feada togeda, e rish 30 fit. One for di first angel feada long rish seven and half fit and e tosh one wall for di temple; why di oda feada na still seven and half fit and e dey tosh di sekond angel feada.
2CH 3:12 One for di sekond angel feada still long rish seven and half fit and e dey tosh di oda wall for di temple; di oda feada na still seven and half fit and e dey tosh di first angel feada.
2CH 3:13 If yu add di two angel feada togeda, na 30 fit dem bi. Dem stand well face inside di temple.
2CH 3:14 Na violet, purpol, crimson and white klot, Solomon take make di curtain kon design and dekorate am with tins wey bi like angels.
2CH 3:15 For di temple front, e make two pila and dem long rish fifty-two and half fit and each of dem high rish seven and half fit.
2CH 3:16 E make strong shains kon put dem on-top di pila. E still make one hundred fruits wey get many seeds kon dekorate and join dem to di shains.
2CH 3:17 E put di pila for di temple front; one for di rite side and di oda for di left, den e koll di one for rite, “Jakin” and di left one, “Boaz.”
2CH 4:1 Solomon make one bronze altar wey long rish 30 fit; wide rish 30 fit and e high rish 15 fit.
2CH 4:2 E still make one bronze basin kon koll am “Di Sea.” If dem measure am from one side to di oda, na 15 fit e bi; e round for shape kon high rish seven and half fit. Di basin round rish 45 fit.
2CH 4:3 Bull wey dem karve dey under am for evriwhere. One melu image dey under am for evry step. Di bull dey two side and dem join dem to “Di Sea.”
2CH 4:4 “Di Sea” stand on-top twelf bull. Three face nort, three face west, three face sout and three face east. “Di Sea” dey on-top dem and all of dem face outside.
2CH 4:5 E tick rish three inches and di tins wey dem take hold am, dey shine like lily flower. E fit kontain like 18,000 gallons of wota.
2CH 4:6 E make ten basin wey dem fit take wosh: E put five for di sout and five for di nort side. Na inside di basin dem for dey wosh di tins wey dem dey take do di burnt sakrifice; but di priest dey wosh inside “Di Sea.”
2CH 4:7 E make ten gold lampstand just as e suppose bi kon put dem for di temple; five for di rite side and five for di left.
2CH 4:8 E make ten tabol kon put dem for di temple; five for di rite side and five for di left. E still use gold take make one hundred bowl.
2CH 4:9 E make di kourtyard for di priests, di big kourt and di door for di kourt kon design dem with bronze.
2CH 4:10 E put “Di Sea” for di sout-side for di sout-east korna.
2CH 4:11 Hiram make di pots, shovels and bowls. E finish all di work for God Temple, just as King Solomon tell am.
2CH 4:12 E make di two pila, di two bowl wey dey on-top di two pila, with two shains wey dem design for di top
2CH 4:13 di 400 fruits wey get many seeds wey dem take design shains for di pilas (each of di design get two of dis fruits on-top di pila),
2CH 4:14 di ten stand wey dem fit move with di ten basins,
2CH 4:15 di big bronze basin wey dem dey koll, “Di Sea” with di twelf bull wey dey under;
2CH 4:16 di pots, shovels and di meat fork. All di tins wey King Solomon give Hiram make e do for God Temple, dem make dem with bronze wey dem polish.
2CH 4:17 Di king sey make dem mold dem kom from Jordan River, between Sukkot and Zaretan.
2CH 4:18 Even with all dis many tins wey Solomon make, di bronze dem still remain.
2CH 4:19 Solomon still make all dis fine tins for God Temple, di golden altar and di tabol wey e go put di sakrifice bread;
2CH 4:20 plus di gold lampstand with dia lamps wey go dey burn for di Most Holy Place, just as Moses kommand
2CH 4:21 and na fine gold dem take make di flower, di lamp and di tongs.
2CH 4:22 Na pure gold dem take make di wick iron, di bowl, spoon and di censer. Na gold dem still take make di door-mot, di house front, inside di door and di temple door.
2CH 5:1 Wen Solomon don build God Temple finish, di holy tins wey bi en papa David own (tins like: silva, gold and all di oda tins) e pak dem put inside di store room for di temple.
2CH 5:2 Den Solomon sey make all di eldas for Israel, plus all di leaders for di tribes and family for Israel, kom meet am for Jerusalem, so dat dem go dey der wen dem dey karry di Kovenant Box kom from David Town (wey bi Zion).
2CH 5:3 Israel men gada go meet di king wen dem dey do di festival for di sevent mont.
2CH 5:4 Wen Israel leaders rish der, na dat time Levi pipol kon karry di Kovenant Box.
2CH 5:5 Di priest and Levi pipol karry di box, di tent where God for appear to di pipol and all di holy tins wey dey inside.
2CH 5:6 For dis time, King Solomon and Israel pipol wey dey der with am kon dey waka for di box front and dem sakrifice many sheep and kattle wey nobody fit kount.
2CH 5:7 Di priest karry di Kovenant Box go where dem sey make dem put am for inside di temple, for di Most Holy Place wey dey under di angels image feada.
2CH 5:8 Di angel image feada kover di place where dem put di box. Di angel wey dem karve, kover di box and en poles.
2CH 5:9 Di poles long well-well sotey dem dey si dia end from di temple main room and di Most Holy Place, but nor bi from outside. Dem still dey der till today.
2CH 5:10 Nor-tin dey inside di box escept di two stones wey Moses put inside for Mount Sinai where God for make kovenant with en pipol Israel, afta dem kom out from Egypt.
2CH 5:11 Den di priests komot from di Most Holy Place. All di priests wey dey der don klean diasef, weda dem dey work dat day or not.
2CH 5:12 Levi pipol wey dey play music na, Asaf, Heman, Jedutun and dia sons and brodas. All of dem wear linen kon stand for di east side for di altar dey play cymbals, lyres and harps. 120 priests wey dey blow trumpet, kon join dem too.
2CH 5:13 Doz wey dey blow trumpet and doz wey dey sing kon dey sing togeda dey praiz and give God all di glory. With di trumpet, cymbals and oda instruments, evribody kon dey shaut praiz God dey sey: “God dey good! En love and goodness, na forever and ever!” At wons, one kind tick kloud kon kover God Temple.
2CH 5:14 So, di priests nor fit kontinue dia work again, bikos of di kloud and na God present with en glory, kover di whole temple.
2CH 6:1 Den Solomon sey, “God don sey na inside tick darkness E dey stay.
2CH 6:2 But naw my Oga God, I don build big temple for Yu; place where Yu go stay forever!”
2CH 6:3 Den di king turn kon bless Israel pipol as dem stand for der.
2CH 6:4 E sey, “Make all praiz bi di Oga wey bi Israel God own, bikos E don do wetin E promise my papa David.
2CH 6:5 E tell David sey, ‘Since di day I take my pipol komot from Egypt, I nor choose any town from all di tribe for Israel wey go build di temple wey I go stay or sey I choose one man as pesin wey go lead my pipol Israel.
2CH 6:6 But naw, I don choose Jerusalem as di place where I go stay and I don choose David make e lead my pipol.’
2CH 6:7 My papa David really won build temple to honor di Oga wey bi Israel God.
2CH 6:8 But God tell am, ‘E dey good as yu get am for mind to build temple to take honor mi.
2CH 6:9 But, yu nor go build am; instead na yor own pikin go build temple take honor mi.’
2CH 6:10 God don do wetin E promise. I don take-ova from my papa David kon sidan for Israel throne, just as E promise. I don build dis temple to honor di Oga wey bi Israel God
2CH 6:11 kon build place for di Kovenant Box and na God make dis kovenant with Israel pipol.”
2CH 6:12 Solomon stand for God altar for Israel pipol present kon spread en hand.
2CH 6:13 E still make one blue stage for di middle. E long rish seven and half fit and na so e wide rish too, but e high rish four and half fit. E klimb di stage kon knee down for all di pipol front, den e raiz en hand go heaven
2CH 6:14 kon pray: “Awa Oga wey bi Israel God, e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for dis eart! Yu dey show yor goodness to yor savant wey dey obey and respet Yu.
2CH 6:15 Yu don do wetin Yu tell yor savant, my papa David sey Yu go do; today-today Yu don do as Yu promise.
2CH 6:16 My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’
2CH 6:17 My Oga wey bi Israel God, make Yu keep di promise wey Yu make to yor savant David.
2CH 6:18 God nor dey really stay with human being for dis eart! Si, if di sky and di heavens wey high pass nor rish Yu stay, den how dis temple go take kontain Yu?
2CH 6:19 But my Oga God, make Yu ansa yor savant prayer kon help am. Make Yu ansa dis prayer wey yor savant dey pray give Yu.
2CH 6:20 Make Yu wosh ova dis temple both for nite and day, bikos Yu promise sey Yu go stay here. Make Yu ansa di prayer wey yor savant dey pray for dis place.
2CH 6:21 Make Yu listin to di prayers wey yor savant and Israel pipol dey pray give Yu from dis place. Make Yu hear from where Yu dey stay for heaven kon ansa well, den forgive us awa sins.
2CH 6:22 Wen dem akuiz pesin sey e sin against en neighbour and dem bring am kom dis temple make e swear,
2CH 6:23 make Yu listin from heaven kon judge di kase. Make Yu ponish di pesin wey dey guilty, den free di one wey dey innocent and make Yu reward di two of dem akordin to wetin dem do.
2CH 6:24 If Yu let enemies win yor pipol Israel, bikos of dia sin, den dem kon turn kom meet Yu for dis temple sey make Yu forgive and help dem,
2CH 6:25 make Yu listin to dem from heaven kon forgive yor pipol, den bring dem kom back to di land wey Yu give dem and dia grand-grand papa.
2CH 6:26 Time dey kom wen di sky go klose and rain nor go fall, bikos yor pipol don sin against Yu. Wen ever dem face dis temple kon pray to Yu, make Yu forgive dem as dem turn from dia sins kom meet Yu, bikos Yu don ponish dem before.
2CH 6:27 Make yu listin from heaven kon forgive yor savants wey bi yor pipol Israel. Den, Yu go tish dem di rite way wey bi life kon make rain fall for yor land wey Yu give dem to stay.
2CH 6:28 Time go kom wen honga go full di eart; diziz, trobol or lokust go dey chop anytin wey dem si; dia enemies go set trap for dem for evriwhere and some oda bad diziz and trobols go happen.
2CH 6:29 Wen yor pipol raiz dia hand go heaven kon face dis temple as dem dey pray to Yu for help, bikos dem dey sofa,
2CH 6:30 make Yu listin to dem from heaven; forgive dia sin kon ansa each pesin akordin to wetin Yu tink sey dey en mind. (True-true, na only Yu fit really know wetin pesin dey tink.)
2CH 6:31 Den, as dem dey for dis land wey Yu give dia grand-grand papa, dem go honor and obey Yu till dem die.
2CH 6:32 Strenjas wey nor join yor pipol Israel, go kom from far place, bikos of di respet wey pipol dey give Yu and bikos Yu get pawa to do evritin wey Yu tok; dem go kom dis temple kon pray.
2CH 6:33 Make Yu listin to dem from heaven kon ansa all di prayers wey di strenjas pray. Den all di nashons for dis eart go know as Yu good rish kon obey Yu, just as yor pipol Israel dey obey Yu. Den dem go know sey dis temple wey I build, na yor own.
2CH 6:34 Wen ever Yu sey make yor pipol go fight dia enemies and dem direct dia prayers to Yu kon face dis town wey Yu choose and dis temple wey I build to honor Yu,
2CH 6:35 make Yu listin to dia prayers for help from heaven kon fight for dem.
2CH 6:36 Di time dey kom wen yor pipol go sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin!) and Yu go dey vex for dem kon give dem to dia enemies wey go take dem go as prisonas for anoda land, weda e far or near.
2CH 6:37 Wen yor pipol don know wetin dem do for dat land where dem for bi prisonas, den, dem turn kom meet and dey beg make Yu forgive and remove dem from di land where dem for bi prisonas, den dem go sey, ‘Wi don sin and do anyhow! Wi don do wiked tin!’
2CH 6:38 Wen dem turn kom meet Yu with all dia heart and mind for di land where dem for dey sofa kon dey pray as dem face dis land wey Yu give dia grand-grand papa and di town wey Yu choose with di temple wey I build to honor Yu,
2CH 6:39 den make Yu listin to dia prayer for help from where Yu dey stay for heaven. Make Yu sorry for dem; help and forgive yor pipol for all di sins wey dem kommit.
2CH 6:40 My God, make Yu dey listin and ansa all di prayers wey dem go pray to Yu from dis place.
2CH 6:41 My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!
2CH 6:42 My God, make Yu nor rijet di pipol wey Yu choose! Make Yu remember di promise wey Yu make give David, yor savant!”
2CH 7:1 Wen Solomon don pray finish, fire kom down from heaven kon burn di ofrin and di sakrifice, den God present kon full inside di temple.
2CH 7:2 Di priests nor fit enter God Temple, bikos God present full der.
2CH 7:3 Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey, “True-true, God dey good; en love wey nor dey fail, go dey forever!”
2CH 7:4 Di king and di pipol kon offa sakrifice give God.
2CH 7:5 King Solomon sakrifice 22,000 kattle and 120,000 sheep. Den en and all di pipol dedikate God Temple.
2CH 7:6 Di priests stand for where dem put dem, plus all di Levi pipol wey dey play music to take praiz God. (Dis na di tins wey King David make to take give God tanks and David dey use dem wen ever e dey praiz God sey, “True-true, yor love dey with us forever.”) Di priest stand near Levi pipol dey blow di trumpets, while evry oda tribe for Israel, stand dey praiz God.
2CH 7:7 Solomon santify di kourtyard centre wey dey God Temple front. Di burnt sakrifice, di korn ofrin and di fat part for di peace ofrin, e offa dem for der, bikos di bronze altar wey Solomon make, too small to kontain all di ofrins.
2CH 7:8 For dat time, Solomon and Israel pipol celebrate for seven days. Pipol from Hamat for nort go rish Egypt wotaside for sout, still dey join dis pipol too.
2CH 7:9 For di eight day, dem gada evribody togeda, bikos dem don dedikate di altar for seven days kon celebrate for anoda seven days.
2CH 7:10 For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.
2CH 7:11 Afta Solomon don build God Temple, di royal palis and evritin wey e plan for God Temple and en royal palis finish,
2CH 7:12 God appear to am for nite kon sey: “I don ansa yor prayers kon choose dis place as my temple where dem go for dey make sakrifice.
2CH 7:13 Wen I klose di sky so dat rain nor go fall, or kommand lokust make dem distroy di plant for di land, or kause betta wahala and diziz,
2CH 7:14 if my pipol go honbol demsef kon pray to mi and turn from dia sins, I go hear and ansa dem from heaven kon forgive dia sins, den heal dia land.
2CH 7:15 I go listin and ansa dia prayers wey dem go pray for dis place.
2CH 7:16 I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.
2CH 7:17 Yu must serve mi, just as yor papa David do. Make yu do evritin wey I kommand and obey my rules well-well.
2CH 7:18 Den I go make yor shidren rule forever, just as I promise yor papa David sey, ‘Yu go always get pikin wey go rule ova my pipol, Israel.’
2CH 7:19 But if yor pipol turn from mi kon dey disobey di rules and kommand wey I sey make dem keep and dem kon dey serve anoda god,
2CH 7:20 I go remove dem from my land wey I give dem; I go forget dis temple wey I santify with my present kon make pipol laf and fool dem among all di nashon.
2CH 7:21 But for dis temple, wey bin dey good and okay, evribody wey dey pass am go shok kon sey, ‘Wetin make God do like dis to dis land and dis temple?’
2CH 7:22 Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”
2CH 8:1 Twenty years afta Solomon don build God Temple and en royal palis,
2CH 8:2 e ribuild di town wey Hiram gi-am kon put Israel pipol for der.
2CH 8:3 E go Hamat-Zoba kon seize am.
2CH 8:4 E build Tadmor for di wildaness and all di towns wey dem for dey keep tins wey E build for Hamat.
2CH 8:5 Di Uppa Bet-Horon and di Lowa Bet-Horon, Solomon make di towns strong with walls and iron gates
2CH 8:6 and e build Baalat. Na en get all di towns where dem for dey keep tins, plus di town where dem keep shariot and ordinary horse put. E build anytin wey e wont for Jerusalem, Lebanon and evriwhere for en kingdom.
2CH 8:7 For dis time, many pipol wey nor bi Israel pipol still dey di land afta Joshua don win Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol.
2CH 8:8 Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today.
2CH 8:9 Solomon nor give Israel pipol dis kind work, bikos na dem bi sojas, ofisas, doz wey dey ride shariot and doz wey dey kommand di sojas.
2CH 8:10 Dis pipol so, dey work for Solomon as supavisor; dem bi 250 wey dey supavise dis pipol.
2CH 8:11 Solomon karry Fero dota from David Town go di palis wey e build for am kon sey, “My wife nor go stay for di palis wey bi Israel king, David own, bikos di place where di Kovenant Box enter, dey holy.”
2CH 8:12 Den Solomon offa sakrifice give God on-top di altar wey e build for di temple front.
2CH 8:13 E do evritin for di sakrifice, just as Moses tok about Sabat Day, New Moon festival and di three celebrashon wey dem dey do wey bi: Bread Wey No Get Yist Feast, Di Week Feast and Di Shelta Feast.
2CH 8:14 As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok.
2CH 8:15 Dem do evritin wey di king orda koncerning di priest, Levi pipol and di propaty dem.
2CH 8:16 All di work wey Solomon sey make dem do, rite from di day wey dem lay di foundashon for God Temple until dem finish am, dem do all komplete. So, dem kon finish all di work for God Temple.
2CH 8:17 Den Solomon go Ezion-Geber, before e kon go Elat wey dey Edom wotaside.
2CH 8:18 Hiram send sheep and some pipol wey sabi kontrol sheep go meet am. Men wey know how to drive for sea. Dem drive with Solomon men go rish Ofir kon take 450 gold from der, den dem bring am kon give King Solomon.
2CH 9:1 Wen Sheba kween hear about Solomon, di woman kon go ask am strong-strong kweshon. Di kween rish Jerusalem with many pipol and many kamel wey karry spices, plenty gold and precious jewels. Wen di kween meet Solomon, e tell am evritin wey e get for en mind.
2CH 9:2 Solomon get ansa for all di kween kweshon; e nor get anytin wey dey too hard for am to esplain give di kween.
2CH 9:3 Wen Sheba kween si di palis wey Solomon build and how di king get sense rish,
2CH 9:4 di woman sopraiz well-well. Di kween still sopraiz for di kind food wey dey di tabol; as Solomon ofisas dey organize and di fine-fine klot wey dem wear; di pesin wey dey hold di cup; dia garment and di burnt ofrin wey Solomon offa for God Temple.
2CH 9:5 Di kween tell Solomon, “Wetin I hear for my kountry about evritin wey yu get and yor wisdom, na true!
2CH 9:6 I nor bilive wetin dem tok until I kom here kom si dem with my own eyes. True-true, I neva even hear half of di wisdom wey yu get! Wetin I dey si so, dem nor even tell mi rish half.
2CH 9:7 Yor pipol go dey happy well-well o-o! Na betta honor for yor ofisas to stand here evriday dey listin to yor wisdom!
2CH 9:8 Make wi praiz di Oga wey bi yor God, bikos E like yu kon give yu dis en great kingdom. God love Israel and en pipol and E wont make dis kingdom last forever. E don make yu king ova dem, so dat yu go rule well and dey good with am.”
2CH 9:9 Den di kween give di king gift wey bi 9,000 pound of gold, many spices and precious jewels. E nor get any spices wey fine rish di ones wey Sheba kween give King Solomon.
2CH 9:10 (Plus all dis ones, Hiram and Solomon savant buy gold from Ofir, plus fine timba and precious jewels.
2CH 9:11 Di king use di timbas take make steps for God Temple, en royal palis kon do instrument for doz wey dey play music. For Judah land, nobody don ever si anytin like dat until dat time.)
2CH 9:12 Evritin wey Sheba kween ask for, King Solomon gi-am and wetin e gi-am many pass wetin di kween bring kom. Den di kween kon go back to en kountry with di men wey follow am kom.
2CH 9:13 Solomon dey kollect 666 pound for gold evry year.
2CH 9:14 All dis nor dey join di oda tins wey e dey get from doz wey dey buy and sell. All Arabia kings and govnor from di aria, dey still bring gold and silva kon gi-am.
2CH 9:15 King Solomon make 200 big shield with gold; na 600 gold wey dem melt for fire, dem take make each one.
2CH 9:16 E still make 300 small shield with gold; na 300 gold wey dem melt for fire, dem take make each one. Di king put dem for di palis for Lebanon Forest.
2CH 9:17 Di king make one big throne wey dem design with ivory kon dekorate am with gold.
2CH 9:18 Di throne get six steps and di place where dem go put leg on-top, na gold dem take do am. Di throne get where dem go rest hand put for di two side and one image like lion dey for di two side for di throne.
2CH 9:19 E still get twelf oda image like lion for di six step; one lion for each end for di six step. E nor get any oda throne for di world wey dem fit use take kompare dis one!
2CH 9:20 All di cup wey king Solomon dey take drink wota or wine, na betta gold dem take make dem, just like all di tins wey dey di palis for Lebanon Forest. Dem nor make dem with silva, bikos wen Solomon dey rule, e nor si silva as anytin!
2CH 9:21 Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.
2CH 9:22 So King Solomon kon get money well-well and wise pass any oda king wey dey dis eart.
2CH 9:23 Kings from evriwhere dey kom meet am make dem for hear from di wisdom wey God gi-am.
2CH 9:24 Evribody wey dey kom visit Solomon, dey bring gift wey bi gold, silva, klot, war tins, spices, horse and melu kom meet am.
2CH 9:25 Solomon get 4,000 place where e dey keep en shariot and ordinary horse put and e get 12,000 horse. E keep dem for some towns wey e choose and for Jerusalem town too.
2CH 9:26 E rule all di kingdoms from Eufrates River go rish Filistia pipol land and e still rish di borda for Egypt side.
2CH 9:27 Di king make silva plenty for Jerusalem like san-san. Cedar wood plenty, just as sikamore fig tree plenty for di low lands.
2CH 9:28 Solomon buy en horse dem from Egypt and many difren kountries.
2CH 9:29 Di remainin tins wey Solomon do, from biginnin go rish di end, dem rite dem put for di book wey Profet Natan rite; plus Ahijah for Shiloh profesy; Iddo wey dey si vishon and di vishon about Jeroboam wey bi Nebat pikin.
2CH 9:30 E rule Israel pipol from Jerusalem for forty years.
2CH 9:31 Wen King Solomon die, dem beri am for David Town, bikos dem name di town afta en papa, David. En pikin Rehoboam kon take-ova as king.
2CH 10:1 Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.
2CH 10:2 Nebat pikin, Jeroboam wey run from Solomon go hide for Egypt, still dey stay der wen e hear dis tin.
2CH 10:3 Dem kon send pesin go koll Jeroboam kom and all of dem go meet Rehoboam kon tell am,
2CH 10:4 “Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon komot dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”
2CH 10:5 Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.
2CH 10:6 King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon sey, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”
2CH 10:7 Dem ansa am, “If yu wont make dis pipol serve yu well; give dem ansa wey dem go like and dem go use all dia heart serve yu forever.”
2CH 10:8 But King Rehoboam nor listin to dem, instead e go ask di yong men wey bi en mate,
2CH 10:9 “Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”
2CH 10:10 Dem ansa, “Make yu tell dem, ‘I hard pass my papa, Solomon!’
2CH 10:11 Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
2CH 10:12 Afta three days, Jeroboam and di pipol go meet King Rehoboam, just as e tell dem.
2CH 10:13 Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just
2CH 10:14 as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work hard well-well. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”
2CH 10:15 Dis na how God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
2CH 10:16 Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol bigin argue among diasef
2CH 10:17 kon waka leave Rehoboam make e bi king to only doz wey dey Judah aria.
2CH 10:18 So King Rehoboam send Adoniram wey bi di workers oga go meet Israel pipol, but dem stone am die and wen King Rehoboam hear wetin happen, e kwik-kwik enter en shariot kon run go Jerusalem.
2CH 10:19 And na since den Israel pipol for nort bigin fight against David kingdom.
2CH 11:1 Wen Rehoboam rish Jerusalem, e koll 180,000 strong sojas from Judah and Benjamin tribe sey make dem go fight Israel tribe wey dey di nort side.
2CH 11:2 But God tell Profet Shemaya sey,
2CH 11:3 “Make yu go tell Rehoboam, Judah and Benjamin pipol sey:
2CH 11:4 ‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house.
2CH 11:5 King Rehoboam for Jerusalem guide and build wall round dis towns for Judah:
2CH 11:6 Betlehem, Etam, Tekoa,
2CH 11:7 Bet-Zur, Soko, Adullam,
2CH 11:8 Gat, Maresha, Zif,
2CH 11:9 Adoraim, Lakish, Azeka,
2CH 11:10 Zorah, Aijalon and Hebron. Na dis towns dem guide well-well for Judah and Benjamin.
2CH 11:11 E guide dis towns well-well kon put ofisas der with store wey dem put food, olive oil and wine.
2CH 11:12 Shield and spear dey for evry town. E make dis town strong well-well. Na-im get Judah and Benjamin.
2CH 11:13 Di priest and Levi pipol wey dey Israel, still dey support am no matter where dem dey stay.
2CH 11:14 Levi pipol leave all dia propaty and betta land kon kom Judah and Jerusalem, bikos Jeroboam with en shidren nor gri make dem serve as God priest.
2CH 11:15 King Jeroboam appoint en own priest dem to dey serve for di woship place and for di juju altar wey e make.
2CH 11:16 All di pipol for Israel wey won woship Israel God follow dem go Jerusalem go sakrifice give dia grand-grand papa God.
2CH 11:17 Dem support Judah kon obey Solomon pikin, King Rehoboam for three years. Dem follow David and Solomon laws for three years.
2CH 11:18 King Rehoboam marry Mahalat wey David pikin, Jerimot born and en mama na Abihail wey Jesse pikin, Eliab born.
2CH 11:19 Dem born three sons: Jeush, Shemaraya and Zaham.
2CH 11:20 King Rehoboam still marry Maaka, wey bi Absalom pikin and dem born four sons: Abijah, Attai, Ziza and Shelomit.
2CH 11:21 All Rehoboam wife na eighteen and en girl-friends na sixty. E born twenty-eight sons and sixty dotas. Na Absalom pikin, Maaka e like pass among en wifes and girl-friends
2CH 11:22 and na Maaka pikin Abijah, e like pass among di oda shidren. So e kon choose Abijah as king afta am.
2CH 11:23 E use sense put en sons as leaders for Judah and Benjamin aria and oda towns wey dem dey guide well-well. E dey give dem evritin kon marry many wifes for dem.
2CH 12:1 Wen Rehoboam dey rule and don get pawa well-well, en and Israel pipol kon rijet God law.
2CH 12:2 Bikos dem nor dey follow God law again, for di fift year wey Rehoboam dey rule, King Shishak for Egypt kon attack Jerusalem.
2CH 12:3 King Shishak bring 1,200 shariot, 60,000 horse-men and many sojas follow am kom from Egypt, Libya, Sukk and Kush.
2CH 12:4 E seize Judah town wey dem fence well-well kon mash face Jerusalem.
2CH 12:5 Profet Shemaya visit Rehoboam and Judah leaders wey gada for Jerusalem, bikos of Shishak kon tell dem sey, “Dis na wetin God tok: ‘Una don rijet mi, so I go rijet and give una to Shishak.’ ”
2CH 12:6 Israel leaders and di king honbol demsef kon sey, “Na di korrect tin God dey do so o-o.”
2CH 12:7 Wen God si sey dem don turn kom meet am, E kon tell Profet Shemaya sey, “Dem don honbol demsef, so I nor go distroy dem again. I go soon diliver dem. I nor go use Shishak take show Jerusalem pipol as I dey vex rish.
2CH 12:8 But Shishak go win dem, so dat dem go know di difren between to serve mi or oda rulers.”
2CH 12:9 King Shishak for Egypt attack Jerusalem kon karry all di good tins wey dey di temple and di gold shield wey Solomon make.
2CH 12:10 King Rehoboam make gold shield take replace dem kon put ofisas to guide di palis gate.
2CH 12:11 Anytime di king go di temple, di guards go karry di shields kom out, den take dem go back to di guard-room wen di king don komot from di temple.
2CH 12:12 Afta Rehoboam honbol ensef, God nor vex distroy am again and evritin kon dey progress for Judah.
2CH 12:13 King Rehoboam kingdom kon strong well-well for Jerusalem. E bi forty-one years wen e start to rule and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God choose among all Israel tribe as en house. King Rehoboam mama kom from Ammon and en name na Naamah.
2CH 12:14 E sin against God bikos e nor gri serve am with en whole heart.
2CH 12:15 Evry oda tin wey King Rehoboam do, dem rite am put for Profet Shemaya and Profet Iddo history book.
2CH 12:16 Den Rehoboam die and dem beri am for David Town. En pikin Abijah kon take-ova as king.
2CH 13:1 For eighteen years wen King Jeroboam dey rule, Abijah kon bi king for Judah.
2CH 13:2 E rule three years from Jerusalem. Na Maaka wey bi Uriel dota from Gibeah, born am. War kon start between King Abijah and King Jeroboam.
2CH 13:3 Abijah attack Jeroboam with 400,000 sojas and Jeroboam get 800,000 sojas.
2CH 13:4 Abijah klimb go Zemaraim mountin, for Efraim hill kountry kon shaut sey: “Jeroboam with all Israel pipol, make una listin to mi!
2CH 13:5 Una nor know sey di oga wey bi Israel God get agriment with David family sey, dem go rule Israel forever?
2CH 13:6 Nebat pikin, Jeroboam fight against David pikin, King Solomon wey bi en masta.
2CH 13:7 Leta e gada some yeye men wey tell and make King Rehoboam do some yeye tins, bikos di king heart nor strong rish to tell dem ‘No’.
2CH 13:8 “Naw, yu won fight against di royal pawa wey God give David shidren-shidren. Yu fit get plenty sojas and yu karry gold juju as yor god.
2CH 13:9 Shebi yu porshu Levi pipol and God priest wey bi Aaron shidren-shidren? Yu put doz wey nor suppose bi priest for dia place, just as oda nashons dey do. Anybody wey kom with seven melu or seven ram fit bi priest for dat fake juju wey yu koll god.
2CH 13:10 “But for us, na di Oga bi awa God and wi nor go ever rijet am. Na Aaron shidren-shidren bi God priests and Levi pipol dey assist dem.
2CH 13:11 Dem dey give God sakrifice wey get betta fine smell both for morning and evening. Dem dey gi-am bread ofrin for klean tabol kon lite di lamp put for di gold lampstand for evening. Wi dey do wetin God sey make wi do, but una don rijet am.
2CH 13:12 Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”
2CH 13:13 But Jeroboam don send some men go attack Judah sojas from dia back. Di real sojas dey for front, while Judah sojas dey for back.
2CH 13:14 Judah men turn kon si sey dem dey attack dem both from front and back. Dem kry to God for help and di priests blow dia trumpet.
2CH 13:15 Judah men and King Abijah wey dey lead dem kon shaut kry give God, so God kon help dem win Jeroboam and Israel sojas.
2CH 13:16 Israel pipol run from Judah sojas and God kon let Judah men win dem well-well.
2CH 13:17 Abijah with en sojas win dem well-well, dem kill 500,000 strong Israel sojas.
2CH 13:18 So Judah men win Israel pipol, bikos dem trust and bilive dia grand-grand papa God.
2CH 13:19 Abijah porshu Jeroboam and en sojas kon take Bethel, Jeshanah and Efron.
2CH 13:20 Jeroboam nor ever get pawa again durin di time wen Abijah dey rule. Afta, God kon kill Jeroboam.
2CH 13:21 Abijah get pawa well-well, e get fourteen wifes, twenty-two sons and sixteen dotas.
2CH 13:22 Di remainin tins wey King Abijah tok and do, dem rite dem put for Profet Iddo book.
2CH 14:1 King Abijah die and dem beri am for David Town. En pikin Asa kon take-ova as king. Wen Asa dey rule, di land get peace for ten years.
2CH 14:2 King Asa do evritin wey God wont.
2CH 14:3 E remove di juju altars kon skata dia stone, den e distroy Asherah juju pole.
2CH 14:4 E kommand Judah pipol make dem dey obey dia grand-grand papa God.
2CH 14:5 Judah town get peace, bikos di king skata all di place and altar where dem for dey serve juju.
2CH 14:6 E build many towns wey dem protet well for Judah and for many years, dem nor fight war, bikos God don give dem peace.
2CH 14:7 Di king tell Judah pipol, “Make wi build wall round dis town kon put towa and strong gate. Di land na awa own, bikos wi dey always obey and do wetin God wont.” So, dem kon build di towns and evritin kon dey go well for dem.
2CH 14:8 King Asa get 300,000 sojas from Judah wey karry shield and spear. E still get 280,000 strong men from Benjamin and dem still karry shield and spear.
2CH 14:9 Zera wey kom from Kush attack dem with 1,000,000 sojas and 300 shariot. E go Maresha,
2CH 14:10 where King Asa for shalenge am. Dem gada to fight for Zefata Valley near Maresha.
2CH 14:11 King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
2CH 14:12 God kon help Asa and Judah pipol and dem kill Kush sojas, while di remainin ones kon run.
2CH 14:13 King Asa with en sojas porshu dem rish Gerar. Dem kill many Kush sojas, bikos dem nor fit fight again. Den Judah men kon karry dia propaty.
2CH 14:14 Dem win all di towns near Gerar, bikos God make dis towns run with fear. Judah men karry dia propaty go house, bikos di propaty for di towns many well-well.
2CH 14:15 Dem still attack doz wey dey keep animals for di towns kon karry many sheep and kamel go back to Jerusalem.
2CH 15:1 God Spirit enter Zabud wey bi Oded pikin.
2CH 15:2 E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
2CH 15:3 For sometaim naw, Israel pipol nor get di true God or priest wey go tell dem di law or wetin to do.
2CH 15:4 Bikos of dia sofa, dem kon turn go meet Israel God. Dem find am until dem si am.
2CH 15:5 For dat time, nobody fit travel as e like, bikos trobol dey evriwhere for di land.
2CH 15:6 One town dey opress anoda town; nashon dey opress nashon, bikos na so God wont am.
2CH 15:7 But as for una, make una dey strong and nor fear, bikos God go reward una work.”
2CH 15:8 Wen King Asa hear dis word and wetin Profet Oded tok, en heart kon strong. E distroy all di juju for Judah and Benjamin land and for all di towns wey e take from Efraim hill. So e ripair God altar wey dey di temple front.
2CH 15:9 E gada all Judah and Benjamin pipol, plus di pipol wey dey for Efraim, Manasseh and Simeon tribe wey dey with am. Many pipol from Israel kom stay der wen dem si sey di Oga God dey with am.
2CH 15:10 For fifteen years wen Asa don bi king, dem kon gada for Jerusalem for di third mont.
2CH 15:11 Dat time, dem offa some tins wey dem karry from war as sakrifice give God and na 700 melu head and 7,000 sheep, dem use.
2CH 15:12 Dem gri sey na only di Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem go serve with dia whole heart.
2CH 15:13 Dem kon kill both yong and old; boys or girls wey nor gri serve God.
2CH 15:14 Dem promise sey dem go serve God kon dey blow trumpet to show sey dem mean wetin dem dey tok.
2CH 15:15 Judah pipol happy, bikos dem make dis promise with all dia heart. Dem find God with dia heart and E hear dia kry kon save dem.
2CH 15:16 King Asa remove en grand-mama, Maaka from en pozishon as kween mama, bikos e make Asherah en juju. King Asa kut di juju kon burn am to pieces for Kidron Valley.
2CH 15:17 Even doh Asa nor skata all di juju for di land, e obey God till e die.
2CH 15:18 E put all di tins wey Abijah en papa, dedikate give God for di temple, with di gold and silva.
2CH 15:19 War nor kon dey again until di thirty-fift years wen Asa dey rule.
2CH 16:1 For thirty-six years wen Asa dey rule for Judah, King Baasha for Israel kon attack Judah. E put sojas for Rama, so dat nobody go enter or komot from di town.
2CH 16:2 King Asa take all di silva and gold wey dey di temple and di royal palis kon send dem with message go give King Ben-Hadad for Siria, wey dey rule Damaskus sey:
2CH 16:3 “I won enter agriment with yu as awa papa do. I don send silva and gold kon give yu. So make yu break yor agriment with King Baasha for Israel, so dat e go komot from my land.”
2CH 16:4 King Ben-Hadad gri with wetin King Asa tok, so e send en sojas go attack Israel towns. Dem win Ijon, Dan, Abel-Maim and all di towns where Naftali pipol dey keep tins put.
2CH 16:5 Wen King Baasha hear di news, e karry en sojas kon komot from Rama.
2CH 16:6 King Asa orda Judah men sey make dem karry di stones and wood wey Baasha take block Rama komot. E kon use dem take build Gibeah and Mizpa.
2CH 16:7 For dat time, Profet Hanani visit King Asa for Judah kon tell am: “Bikos yu bilive Siria king pass God, yu nor go fit win Siria sojas again.
2CH 16:8 Kush and Libya pipol nor get plenty sojas, shariot and many men wey dey ride horse for dem? But wen yu trust God, E kon give dem to yu.
2CH 16:9 E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
2CH 16:10 Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.
2CH 16:11 All di tins wey happen wen King Asa dey rule, dem rite dem put for Judah and Israel kings history book.
2CH 16:12 For thirty-nine years wen King Asa dey rule, e kon get diziz for leg. Even doh di sickness dey worse well-well, Asa nor gri pray to God at-all, instead e kon dey go meet difren doctors.
2CH 16:13 King Asa die for di forty-first year wey e bi king.
2CH 16:14 Dem beri am for en own grave for David Town. Dem pour spices and betta oil for en body kon make and burn big fire to take honor am.
2CH 17:1 Asa pikin, Jehoshafat kon take-ova as king.
2CH 17:2 E pak sojas full Judah towns kon send some go difren place for Judah land and for Efraim towns wey en papa seize.
2CH 17:3 God bin dey with Jehoshafat wen e start to rule, bikos e dey obey God like David en grand-grand papa. E nor gri serve juju,
2CH 17:4 instead e serve and obey en grand-grand papa God. E nor do like Israel pipol.
2CH 17:5 Bikos God guide en kingdom, Israel pipol kon take gift go give Jehoshafat, so e get enough money and pipol kon dey respet am.
2CH 17:6 E like to obey God and e skata evriwhere wey dem for dey woship Asherah juju for Judah.
2CH 17:7 For di third year wen e dey rule, e send Ben-Hail, Obadaya, Zekaraya, Netanel and Mikaya wey bi en ofisas go tish pipol for Judah towns.
2CH 17:8 Shemaya, Netanaya, Zebadaya, Asahel, Shemiramot, Jonatan, Adonijah, Tobijah and Tob-Adonijah wey kom from Levi tribe and Priest Elishama with Priest Jehoram, still follow dem.
2CH 17:9 Dem dey tish Judah pipol from di book wey God law dey. Dem travel go all di towns for Judah dey tish di pipol.
2CH 17:10 God put fear for all di kingdom wey near Judah and dem nor fight with King Jehoshafat at-all.
2CH 17:11 Some Filistia pipol bring many silva and gold as gifts kon give Jehoshafat. Arab pipol bring 7,700 rams and 7,700 goats from dia animals kon gi-am.
2CH 17:12 Jehoshafat kon dey get pawa more-more. E build big-big house and towns full Judah.
2CH 17:13 E get many tins wey e store for Judah town kon keep many sojas for Jerusalem.
2CH 17:14 Na like dis dem take divide dia families: dem get 1,000 ofisas from Judah. Adnah wey bi kommander, dey lead 300,000 strong sojas.
2CH 17:15 Jehohanan wey bi kommander, dey lead 280,000
2CH 17:16 and Amasaya wey bi Zikri pikin wey sey e go serve God, dey lead 200,000 strong sojas wey get skill.
2CH 17:17 From Benjamin family: Eliada wey bi strong soja dey lead 200,000 men wey karry bow and shield,
2CH 17:18 while Jehozabad dey lead 180,000 strong sojas.
2CH 17:19 Na dis ones serve di king, apart from doz wey di king put for di strong towns for Judah.
2CH 18:1 Afta King Jehoshafat get money kon popula well-well, e sey make one pesin for en family marry from King Ahab family for Israel.
2CH 18:2 Afta some years, Jehoshafat travel go meet King Ahab for Samaria. King Ahab kill many sheep and melu as respet for King Jehoshafat with en men wey kom visit am. E beg King Jehoshafat make e join am attack Ramot pipol for Gilead town.
2CH 18:3 King Ahab ask King Jehoshafat, “Yu go follow mi go attack Ramot Gilead?” Jehoshafat ansa, “Mi and my sojas dey ready, if yu ready.
2CH 18:4 But make wi ask God first.”
2CH 18:5 So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”
2CH 18:6 But King Jehoshafat ask, “E nor get anoda profet wey wi fit use take ask God?”
2CH 18:7 King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
2CH 18:8 Den King Ahab koll di offisa for di kourt kon sey make e go bring Profet Mikaya kom.
2CH 18:9 Di two kings wear dia royal robes kon sidan for dia thrones for di gardins for Samaria gate and all di profets bigin profesai for dem.
2CH 18:10 One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”
2CH 18:11 All di oda profets tok di same tin sey, “Make yu go fight for Ramot Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
2CH 18:12 Di ofisas wey go koll Mikaya, tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
2CH 18:13 But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go tok wetin God sey make I tok!”
2CH 18:14 Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot Gilead or make wi nor go?” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
2CH 18:15 But King Ahab ask am, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”
2CH 18:16 Mikaya ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, make dem go house with peace.’ ”
2CH 18:17 King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”
2CH 18:18 Mikaaya still sey, “Make yu listin to wetin God tok! I si God sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand round am.
2CH 18:19 Den God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’ “Di angels kon dey tok difren tins,
2CH 18:20 until one spirit kom out kon tell God, ‘I go-go deceive am.’
2CH 18:21 “God ask, ‘How yu wont take deceive am?’ “Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’ “God kon sey, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
2CH 18:22 Profet Mikaaya still sey, “Dis na how God wont make e bi. God don make dis profets lie to yu, bikos en ensef don sey, yu go si wahala!”
2CH 18:23 Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to only yu?”
2CH 18:24 Mikaya ansa, “Wen yu go don hide inside yor room, den yu go know di trut.”
2CH 18:25 King Ahab kon orda sey, “Make una arrest and karry Mikaya go Amon wey bi di main town where Prince Joash bi govnor.
2CH 18:26 Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”
2CH 18:27 Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una listin to wetin I don tok!”
2CH 18:28 Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead.
2CH 18:29 King Ahab tell King Jehoshafat, “As wi dey go di war so, I go shange mysef, but make yu wear yor royal robe.” So Israel king shange kon go di war.
2CH 18:30 Siria king don kommand en kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king.
2CH 18:31 So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut and God help am.
2CH 18:32 Den Ramot sojas kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.
2CH 18:33 Leta, one Siria soja shot en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse sey, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”
2CH 18:34 As dem dey fight thru-out dat day, di king just sleep for en shariot face Siria pipol. For evening wen sun don go down, di king kon die.
2CH 19:1 Wen King Jehoshafat for Judah rish en house for Jerusalem,
2CH 19:2 Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.
2CH 19:3 But yu don still do some good tins before. Yu remove Asherah juju from di town and yu really won follow God.”
2CH 19:4 As Jehoshafat dey stay for Jerusalem, e dey follow di pipol travel from Beersheba go di hill kountry for Efraim and e dey advise dem make dem follow dia grand-grand papa God.
2CH 19:5 E put judge for all di land for Judah towns wey dem dey guide.
2CH 19:6 King Jehoshafat tell di judge dem, “Make una dey kareful for wetin una dey do, bikos una nor dey judge for men, but na for God wey go dey with una wen una dey make decision.
2CH 19:7 Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”
2CH 19:8 For Jerusalem, King Jehoshafat put some Levi pipol, priest and some Israel family for Israel as God judge and to dey setol wahala.
2CH 19:9 E kommand dem sey, “Make una get respet for God as una dey do una work with klean heart.
2CH 19:10 Wen ever una kountry man kon ripot matter give una (weda e koncern pesin wey dem kill or about di law and kommandments), make una warn dem sey make dem nor sin against God. If una nor do like dat, God go vex for una and doz wey dey work with una, but if una obey am, una go dey free.
2CH 19:11 “Any matter wey koncern di king, una go ripot to Amaraya wey bi di shief priest and Ishmael pikin, Zebadaya wey dey lead Judah family. Levi pipol go bi una ofisas. Make una do una work well! Make God dey with doz wey dey do well!”
2CH 20:1 Afta, Moab and Ammon pipol with some pipol from Meun kon attack Jehoshafat.
2CH 20:2 Some messenjas go tell Jehoshafat sey, “Plenty sojas dey attack yor town from di oda side for di Dead Sea for Edom side, for Hazezon Tamar wey bi En-Gedi.”
2CH 20:3 Jehoshafat kon dey fear, so e go meet God. E kommand evribody for Judah sey make dem fast.
2CH 20:4 Judah pipol from difren town gada togeda kom sey make God help dem.
2CH 20:5 King Jehoshafat stand for where Judah and Jerusalem pipol gada put for di kourtyard front, wey dey God Temple
2CH 20:6 kon pray: “My Oga wey bi awa grand-grand papa God, na Yu bi God wey dey for heaven and na Yu dey rule di whole world. Na Yu get all pawa and nobody fit stand against Yu.
2CH 20:7 Awa Oga God, Yu porshu doz wey dey dis land before kon gi-am to yor friend Abraham and en shidren-shidren Israel, wey bi yor pipol.
2CH 20:8 Dem stay di town kon build temple put as respet for Yu sey,
2CH 20:9 ‘If wahala kom meet us like sojas attack us, judgement, sickness or sey food nor dey, wi go kry kon meet Yu with awa pain, so dat Yu go hear and diliver us.’
2CH 20:10 Naw, Ammon, Moab and pipol for Mount Seir dey kom! Wen Israel pipol komot from Egypt, Yu nor gri make dem fight dis pipol. Dem just pass and dem nor tosh dem.
2CH 20:11 But naw, make Yu si how dem dey pay us back. Dem dey kom drive us komot from awa land wey Yu give us!
2CH 20:12 Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
2CH 20:13 All di men for Judah, dia wifes and shidren kon stand for God front.
2CH 20:14 Den Zekaraya wey Benaya born, God Spirit kon enter en pikin Jahaziel, for all di pipol present. Na Jeiel wey Matanaya born bi Benaya papa. Dem bi Levi pipol from Asaf family.
2CH 20:15 Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’
2CH 20:16 Make una go fight dem tumoro as dem dey kom Ziz. Una go si dem for one small river for Jeruel Desert front.
2CH 20:17 Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”
2CH 20:18 King Jehoshafat kon bow and Judah pipol with doz wey dey stay Jerusalem, bow woship God.
2CH 20:19 Den some Levi pipol wey kom from Kohat and Korah get up kon shaut dey praiz God.
2CH 20:20 Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.”
2CH 20:21 Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”
2CH 20:22 As dem dey sing, na wons God attack Ammon, Moab and di men from Mount Seir wey dey kom fight Judah pipol, so Judah men win all of dem.
2CH 20:23 Ammon and Moab men attack di men wey kom from Mount Seir kon distroy dem. Wen dem kill Seir men finish, dem kon start to kill demsef.
2CH 20:24 Wen Judah men rish di war front for di desert, na only dead body, dem si for groun.
2CH 20:25 King Jehoshafat with en men kon go pak di sojas tins. Dem pak dia klot and many oda betta tins. E take dem like three days to pak all di tins, bikos dem plenty well-well.
2CH 20:26 For di fourt day, dem gada go Beraca Valley kon praiz God for der. Na Beraca Valley dem dey koll dat place till today.
2CH 20:27 All di men for Judah and Jerusalem kon dey happy as dem dey go Jerusalem and na Jehoshafat dey lead dem. God don give dem viktory ova dia enemies.
2CH 20:28 Dem enter Jerusalem with trumpet and oda tins wey dem take dey sing kon dey happy and dance go God Temple.
2CH 20:29 All di oda kingdom wey near dem kon dey fear God wen dem hear as E fight Israel pipol enemies.
2CH 20:30 So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.
2CH 20:31 King Jehoshafat reign for Judah. E bi thirty-five years wen e start to rule and e rule for twenty-five years from Jerusalem. En mama na Azuba wey bi Shilhi pikin.
2CH 20:32 E follow wetin Asa en papa do and e dey kareful and dey do only wetin God wont.
2CH 20:33 But e nor still skata all di place where dem for dey serve juju and di pipol nor use all dia mind serve dia grand-grand papa God.
2CH 20:34 Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
2CH 20:35 Leta, King Jehoshafat make friend with King Ahazaya for Israel wey do many wiked tins.
2CH 20:36 Dem agri to make ship wen dem go take travel go Tarshish and dem make di ship for Ezion-Geber.
2CH 20:37 Dodavahu pikin Elieza from Maresha kon tok against King Jehoshafat sey, “Bikos yu enter agriment with King Ahazaya, God go skata wetin yu don make.” Di ship sink and e nor fit go Tarshish again.
2CH 21:1 Jehoshafat die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Jehoram kon take-ova as king.
2CH 21:2 Jehoram brodas na Zabud, Jehiel, Zekaraya, Azariahu, Mikael and Shefataya. All of dem na King Jehoshafat pikin.
2CH 21:3 Dia papa give dem gold, silva and many oda good tins with towns for Judah wey dem guide well, but e give di kingdom to Jehoram, bikos na-im bi di first pikin.
2CH 21:4 Jehoram kontrol en papa kingdom kon get pawa well-well. Den e kill all en brodas and some ofisas for Israel.
2CH 21:5 Jehoram na thirty-two years wen e start to rule and e rule rish eight years from Jerusalem.
2CH 21:6 E follow Israel king footstep just as Ahab rule. E marry Ahab pikin kon do wiked tins for God present.
2CH 21:7 But God nor won distroy David kingdom, bikos E promise am sey en kingdom go dey forever.
2CH 21:8 Wen Jehoram dey rule, Edom pipol free diasef from Judah kontrol and dem kon choose king for demsef.
2CH 21:9 Jehoram cross go Zair with en ofisas and all en shariot. Edom pipol wey dey near am kon attack and win en with en ofisas for nite.
2CH 21:10 Na dis make Edom pipol dey free from Judah pawa kon rish naw. For dat same time, Libnah still fight free demsef from Judah pawa, bikos King Jehoram rijet en papa God.
2CH 21:11 E still build juju place for Judah hills, den Jerusalem and Judah pipol nor kon dey obey di Oga dia God.
2CH 21:12 King Jehoram receive dis leta from Profet Elijah: “Dis na wetin yor grand-grand papa, David God tok: yu nor follow Jehoshafat yor papa and King Asa for Judah footstep,
2CH 21:13 instead, yu dey sin like Israel kings. Yu make Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem turn from God, just as Ahab family do for Israel. Yu still kill yor brodas and yor papa family wey betta pass yu.
2CH 21:14 So, God go send sickness kom meet yor pipol, yor sons, yor wifes and evribody wey bi yor own.
2CH 21:15 Yu go get sirious diziz wey go make yor intestine swell-up.”
2CH 21:16 God make some Filistia and Arab pipol wey dey stay near di river go fight war with King Jehoram.
2CH 21:17 Dem attack Judah kon karry evritin wey dem si for di palis; plus di king sons, en wifes, but dem leave en yongest son, Ahazaya.
2CH 21:18 Wen all dis tins don happen, God kon ponish am with betta diziz for intestine and nobody fit heal am.
2CH 21:19 Afta two years, en intestine swell-up well-well and e kon die with pain. En pipol nor make big fire take beri am, just as dem beri en grand-grand papa dem.
2CH 21:20 King Jehoram na thirty-two years wen e bi king and e rule for eight years from Jerusalem. En deat nor pain anybody at-all and dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
2CH 22:1 Pipol wey dey stay Jerusalem kon make Jehoram yongest pikin king, bikos Arab pipol wey skata di town kill all di oda shidren. So Ahazaya wey bi Jeroham pikin kon bi king for Judah.
2CH 22:2 Ahazaya na twenty-two years wen e start to rule and e rule for one year from Jerusalem. Na Atalaya wey Omri born bi en mama.
2CH 22:3 E sin like King Ahab, bikos of di wiked advise wey en mama dey gi-am.
2CH 22:4 E do bad-bad tins for God eye just like Ahab, bikos wen en papa die, di pipol wey dey gi-am advise kon make am sin well-well.
2CH 22:5 E follow dia advise kon go join Ahab son, King Joram for Israel. Dem go fight against King Hazael for Ramot Gilead wey dey Siria and Siria pipol win King Joram and en men.
2CH 22:6 Ahab pikin, King Joram go Jezrel go heal di wound wey e get for Rama wen dem dey fight against King Hazael for Siria and Jehoram pikin, King Ahazaya kon go visit am.
2CH 22:7 God kon make Ahazaya kingdom skata, bikos e go visit Joram. Wen Ahazaya rish der, e kon follow Joram go meet Nimshi pikin, Jehu wey God choose to take distroy Ahab family.
2CH 22:8 As Jehu dey distroy Ahab family, e kon si Judah pipol ofisas, Ahazaya sons and en relashon wey dey serve am. So Jehu kill all of dem.
2CH 22:9 Dem find Ahazaya until dem si am for where e hide for Samaria. Dem bring am kon give Jehu and e kill-am. Dem just beri en body, bikos dem dey respet en grand-papa, King Jehoshafat, wey use all en mind take serve God. E nor get anybody for Ahazaya family wey remain to rule as king.
2CH 22:10 Wen Ahazaya mama, Atalaya, si sey en pikin don die, e kon sey e must skata di whole Judah king family.
2CH 22:11 Jehoshabeat wey bi King Jehoram dota, karry Ahazaya son Joash run komot from di place where dem for won kill di king family. E hide am with one nurse for one room, so dat Atalaya nor go si or kill-am. Na dis Jehoshabeat bi Priest Jehoiada wife.
2CH 22:12 Dem hide am for God Temple for six years wen Atalaya dey rule di land.
2CH 23:1 For di sevent year, Priest Jehoiada kon make plan with five sojas wey bi: Zabud wey Jeroham born, Ishmael wey bi Jehohanan pikin, Zabud wey Obed born, Maaseaya wey bi Adaya pikin and Elishafat wey Zikri born.
2CH 23:2 Dem travel go Judah kon gada Levi pipol wey dey di towns with Israel pipol family leaders kom Jerusalem.
2CH 23:3 All di pipol wey gada, kon make kovenant with di king for God Temple. Priest Jehoiada tell dem, “Di king pikin go rule as God promise dia family.
2CH 23:4 Dis na wetin una go do. Wen dem don divide di priest and Levi pipol wey dey duty for Sabat Day, one part must dey wosh di door.
2CH 23:5 Anoda part go stand for di palis gate and di oda part go dey di foundashon gate. All di pipol wey remain go stand for di kourtyard for God Temple.
2CH 23:6 Make nobody enter God Temple escept di priest and Levi pipol wey dey duty. Dem fit enter bikos dia hand klean, but make di oda pipol dey outside.
2CH 23:7 Levi pipol must gada round di king and evribody go hold en weapon for hand. Anybody wey won enter di temple, make una kill-am. Una must follow di king go anywhere wey e dey go.”
2CH 23:8 So Levi pipol and Judah men do as Priest Jehoiada tell dem. Di kommander gada all di men wey dey duty and doz wey nor dey duty for dat Sabat Day.
2CH 23:9 Priest Jehoiada give di sojas King David spears and shields wey dey God Temple.
2CH 23:10 E put all di men for pozishon with dia spear for dia hand. Dem line-up from di sout go rish nort for di temple and dem stand near di altar for di temple kon gada round di king.
2CH 23:11 Priest Jehoiada and en sons lead di king pikin kom out with di crown and king klot wey dem wear for en body. Dem make am king kon pour oil for en head dey shaut, “Make di king live forever!”
2CH 23:12 Wen Atalaya hear di royal guards dey shaut and praiz di king, e kon go where di pipol gada for di temple.
2CH 23:13 E si di king stand near di pila for where dem take dey enter di temple. Di ofisas and doz wey dey blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land happy dey blow dia trumpet. Doz wey dey sing, dey der with difren instrument as dem dey lead di song. Atalaya tear en klot kon dey shaut, “Dis na wayo! Dis na wayo!”
2CH 23:14 Priest Jehoiada koll di ofisas oga kon tell dem, “Make una karry am go outside di temple kon gi-am to di guards. Make una kill anybody wey won stop una.” Di priest do like dis, bikos e nor wont make dem kill-am for inside God Temple.
2CH 23:15 Dem seize Atalaya, karry am go di palis kon kill-am for di horse gate.
2CH 23:16 Priest Jehoiada kon make kovenant sey en with all di pipol and di king go dey obey God.
2CH 23:17 All di pipol kon go distroy di juju temple. Dem skata di altar with all di juju wey dey inside. Dem kill Mattan wey bi Baal priest for di altar front.
2CH 23:18 Priest Jehoiada put di priest and Levi pipol make dem dey work for di temple. E sey make dem do di duty wey King David give dem and burn di sakrifice wey dem give God with joy kon dey play music, just as dem rite am for Moses Law.
2CH 23:19 Priest Jehoiada still put guards for God temple gate, so dat doz wey dey plan bad tin against di king, nor go fit enter di temple.
2CH 23:20 E koll di soja ofisas, di eldas, doz wey dey rule di pipol and all di pipol for di land, den kon lead di king komot from God Temple. Dem use di gate for up take enter di palis and di king kon sidan for en throne.
2CH 23:21 Di pipol for di land kon dey celebrate, bikos since dem kill Atalaya, di town kon get peace.
2CH 24:1 Joash na seven years wen e start to rule. E rule for forty years from Jerusalem. Na Zibaya wey kom from Beersheba bi en mama.
2CH 24:2 King Joash obey God thru-out di time wen Priest Jehoiada dey alive.
2CH 24:3 Priest Jehoiada choose two wife for King Joash and e get sons and dotas.
2CH 24:4 Wen e don bi king for sometaim, e kon won ripair God Temple.
2CH 24:5 E gada di priest and Levi pipol kon orda dem sey, “Make una go Judah towns go kollect plenty money kom from di pipol make wi take ripair God Temple.” E sey make dem kwik-kwik kollect am, but Levi pipol nor kwik rish der.
2CH 24:6 So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
2CH 24:7 (Atalaya wiked well-well and en sons break enter God Temple kon use all di tins wey dey der take woship Baal juju.)
2CH 24:8 Di king orda sey make dem make one box kon put am outside God Temple gate.
2CH 24:9 So dem send message go Jerusalem and Judah make evribody bring di tax, wey God savant, Moses, sey make Israel pipol dey pay wen dem dey wildaness.
2CH 24:10 All di ofisas and di pipol kon happy as dem dey put dia silva inside di box till e full.
2CH 24:11 Anytime wen Levi pipol si sey di box wey di royal money dey don full, doz wey dey kount di money go remove all di money kon karry di box go back to di gate. Na so dem dey do am evriday, until dem kollect plenty money.
2CH 24:12 Di king and Priest Jehoiada give di money to doz wey dem sey make dem ripair God Temple. Dem hire karpenter, doz wey get handwork, doz wey dey do bronze and iron sey make dem ripair God Temple.
2CH 24:13 Dem work well-well kon ripair di temple. Dem follow as di measurement bi for di temple kon do am like dat.
2CH 24:14 Wen dem don finish, dem karry di silva wey remain go give di king and Priest Jehoiada. Dem use am make difren tins for God Temple: tins wey dem take dey serve God for di temple; tins to take burnt sakrifice; pans with oda tins wey dem use gold and silva take make. Wen Priest Jehoiada dey alive, dem dey always burnt sakrifice for di temple.
2CH 24:15 Priest Jehoiada old well-well and e die wen e bi one hundred and thirty years.
2CH 24:16 Dem beri am for David Town with di oda kings, bikos e do good tins for Israel and for God Temple.
2CH 24:17 Wen Priest Jehoiada don die, Judah leaders kon visit di king, bikos of dia respet for Jehoiada. Di king kon listin to dia advise.
2CH 24:18 Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol.
2CH 24:19 God send profet go meet dem, so dat dem go turn back kom meet am. Dem warn dem well-well, but dem nor gri listin.
2CH 24:20 God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”
2CH 24:21 Dem plan kon stone Zekaraya die for God kourtyard.
2CH 24:22 Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”
2CH 24:23 As di year dey start, Siria sojas attack Judah and Jerusalem kon karry many tins go Damaskus.
2CH 24:24 Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.
2CH 24:25 Dem wound am well-well. So wen dem don fight finish, den two of en ofisas kon plan and kill-am for en bed, bikos of Zekaraya wey e kill. Dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
2CH 24:26 Doz wey plan against am na, Zabad wey one Ammon woman, Shimeat born and Jehozabad wey one Moab woman, Shimrit born.
2CH 24:27 King Joash sons names, di tins wey dem profesai against Joash and as e take build God Temple again, dem rite am put for di kings book. Amazaya en pikin kon take-ova as king.
2CH 25:1 Amazaya na twenty-five years wen e bigin rule and e rule Jerusalem for twenty-nine years. Na Jehoaddin wey kom from Jerusalem bi en mama.
2CH 25:2 Even doh e dey obey God, e nor serve am with en whole heart.
2CH 25:3 Wen e don get pawa well-well for di throne, e kon kill di savants wey kill en papa.
2CH 25:4 E nor kill dia papa, bikos e obey God kommand wey dem rite for Moses Law sey, “Make dem nor kill pikin, bikos of en papa sin or kill papa, bikos of en pikin sin.”
2CH 25:5 Amazaya gada Judah pipol, divide dem into difren family kon give dem to di sojas oga wey dey kontrol 1,000 pipol and doz wey dey kontrol hundred pipol for Judah and Benjamin tribe. E kount doz wey don rish and pass twenty years and dem bi 300,000 men wey strong rish to fight. So dem kon give dem spears and shields make dem take go fight.
2CH 25:6 Amazaya hire 100,000 sojas from Israel kon pay dem 7,500 pounds.
2CH 25:7 But one profet go meet am kon sey: “My king! Make yu nor allow Israel sojas follow yu go, bikos God nor dey with Israel and Efraim pipol.
2CH 25:8 Even if yu fight well for di war, God go make yor enemies win yu. Na only God get di pawa to help and fight for pesin.”
2CH 25:9 Den King Amazaya kon ask di profet, “Wetin yu wont make I do about di money wey I don pay take hire dem?” Di profet ansa, “God go give yu pass dat one.”
2CH 25:10 So, King Amazaya kon tell di sojas wey kom from Efraim sey make dem go house. Dem vex well-well for Judah pipol as dem dey go dia house.
2CH 25:11 King Amazaya use strong heart take lead en sojas go Salt Valley, where e for fight and win 10,000 Edom pipol.
2CH 25:12 Judah men katch 10,000 men kon take dem go on-top one hill den trow dem go down till dem die finish.
2CH 25:13 Di pipol wey King Amazaya nor gri make dem follow am go fight kon go attack Judah towns wey dey near Samaria and Bet-Horon. Dem kill 3,000 men kon karry many of dia tins go.
2CH 25:14 Wen Amazaya kill Edom pipol finish, e kom back with Seir pipol juju kon make dem en god. E dey bow, woship and sakrifice give dem.
2CH 25:15 God vex for King Amazaya, so E send one profet go meet and tell am, “Why yu dey follow doz gods wey nor fit save dia own pipol from yor pawa?”
2CH 25:16 As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”
2CH 25:17 Afta King Amazaya for Judah don tok to en advisers, e kon send message go meet Jehu grand-pikin, King Joash for Israel wey Jehoahaz born sey: “If yu get pawa, make yu kom follow mi fight.”
2CH 25:18 King Joash for Israel kon send message go back to King Amazaya sey, “Shuku-shuku for Lebanon send dis message go give cedar tree for Lebanon sey, ‘Make my son marry yor dota, den one wiked animal for Lebanon kon mash di shuku-shuku die.’
2CH 25:19 Di win wey yu win Edom pipol don dey won make yu kraze. Make yu stay for yor palis. Why yu won bring wahala kon give yorsef. Why yu won distroy yorsef and Judah tribe?”
2CH 25:20 But King Amazaya nor hear en warnin. God won give dem to King Joash, bikos dem follow Edom gods.
2CH 25:21 So King Joash attack King Amazaya for Israel. Di two of dem kon face diasef for Bet-Shemesh for Judah.
2CH 25:22 Israel win Judah pipol and all of dem kon run go back to dia house.
2CH 25:23 For Bet-Shemesh, King Joash katch King Amazaya wey Joash born kon karry am go Jerusalem. Na Jehoahaz born Joash. E skata Jerusalem wall, from Efraim gate go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
2CH 25:24 Di gold, silva and di tins wey dey God Temple wey dem sey make Obed-Edom dey look, e karry all of dem go. E still karry all di rish tins for di palis and some pipol go Samaria.
2CH 25:25 King Amazaya wey Joash from Judah born, dey for fifteen years afta King Joash wey bi Jehoahaz pikin for Israel, don die.
2CH 25:26 Di remainin tin wey King Amazaya do wen e dey rule, dem rite dem for Judah and Israel king history book.
2CH 25:27 From di time wey King Amazaya stop to follow God, pipol kon dey plan against am for Jerusalem. E run go Lakish, but dem send pipol follow am kon kill-am for der.
2CH 25:28 Dem use horse karry en dead body go beri for Jerusalem with en grand-grand papa dem for David Town.
2CH 26:1 All di pipol for Judah kon make Uzzaya king afta en papa, Amazaya don die.
2CH 26:2 Afta Amazaya die, King Uzzaya ribuild Elat for Judah pipol.
2CH 26:3 Uzzaya na sixteen years wen e start to rule and e rule for fifty-two years from Jerusalem. En mama name na Jekolaya wey kom from Jerusalem.
2CH 26:4 E obey God, just as en papa King Amazaya bin do.
2CH 26:5 E follow God wen Zekaraya dey alive, bikos e tish am how to honor God. God make am prosper as e dey follow am.
2CH 26:6 Uzzaya attack Filistia pipol kon skata Gat, Jabneh and Ashdod wall. E build towns for Ashdod and all Filistia aria.
2CH 26:7 God help am fight Filistia, Arab and Meun pipol wey dey Gur Baal.
2CH 26:8 Ammon pipol dey respet Uzzaya well-well, so e kon get pawa and e rule go rish Egypt side.
2CH 26:9 King Uzzaya build towas for Jerusalem near di Korna Gate, di Valley Gate and for di wall korna, den e fence dem round.
2CH 26:10 E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
2CH 26:11 King Uzzaya get many sojas wey dem train to fight war; dem arrange di sojas for difren group, just as Jeiel wey dey rite and Maaseaya wey bi di ofisas, wen Hananaya bi di sojas oga, do am.
2CH 26:12 All di family leaders wey lead sojas, na 2,600.
2CH 26:13 Dem dey kommand 307,500 sojas wey get skill and fit fight and dem ready to fight for dia king.
2CH 26:14 King Uzzaya give all di sojas shield, spears, helmet, breast-plates, bows and katapault stones.
2CH 26:15 E make war machine for Jerusalem wey dem take dey shot arrow with big stones from di towas and di wall kornas. E get pawa well-well, bikos pipol dey support am.
2CH 26:16 E kon use en pawa take distroy ensef, bikos e nor gri obey God again. E enter God Temple kon offa incense for di altar.
2CH 26:17 Priest Zabud and di oda eighty priest wey get mind follow am enter di temple.
2CH 26:18 Dem go meet King Uzzaya kon tell am, “E nor good make yu offa incense give God by yorsef, bikos dat na di work wey priests dey do and na Aaron shidren-shidren dem anoint to dey offa incense. Make yu komot from God house, bikos yu don disobey and nor gri respet am!”
2CH 26:19 So King Uzzaya kon dey vex and e hold di incense plate for hand. As e dey shaut for di priests, one kind skin diziz kom out for en fore head for di temple near di incense altar.
2CH 26:20 Wen Priest Zabud and di oda priests look am well, dem kon si di diziz for en fore head. So di priests hurry karry am komot, bikos dem si sey God don ponish am.
2CH 26:21 Dat diziz sofa King Uzzaya until di day wen e die. Dem separate am from pipol, bikos of di diziz and dem nor let am enter God Temple again. En pikin Jotam kon take-ova as king.
2CH 26:22 Di remainin tin wey Uzzaya do wen e dey rule, dem rite dem put for Profet Isaya wey bi Amos pikin book.
2CH 26:23 King Uzzaya die and dem beri am near en grand-grand papa for where dem dey beri kings. (Dis na bikos e get skin diziz.) En pikin Jotam kon take-ova as king.
2CH 27:1 Jotam na twenty-five years wen e start to rule and e rule for sixteen years from Jerusalem. En mama name na Jerusha wey Zadok born.
2CH 27:2 E obey God, just like en papa Uzzaya. (E nor enter di temple go burn incense like en papa). But di pipol still dey sin.
2CH 27:3 E build di gate for up wey dem take dey go God Temple kon do plenty work for di wall wey dey di hill.
2CH 27:4 E build towns for di hill side for Judah kon build strong place and towas for di forest.
2CH 27:5 King Jotam fight against Ammon king with en sojas kon win dem. For dat year, Ammon pipol pay am 7,500 pounds for silva, 10,000 bags for wheat and 10,000 bags for barley. Ammon pipol still pay dis tins for anoda two years.
2CH 27:6 King Jotam grow kon get pawa, bikos e dey obey di Oga wey bi en God.
2CH 27:7 Di remainin tins wey e do wen e dey rule; di war wey e fight and en laws, dem rite dem for Israel and Judah kings history book.
2CH 27:8 E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule for sixteen years from Jerusalem.
2CH 27:9 Jotam die and dem beri am for David Town. En pikin Ahaz kon take-ova as king.
2CH 28:1 Ahaz na twenty years wen e start to rule and e rule for sixteen years from Jerusalem. E nor do wetin God wont or follow en grand-grand papa David footstep.
2CH 28:2 Israel kings wey make Baal juju before, na dia footsteps e follow.
2CH 28:3 E use en sons take do sakrifice for Ben-Hinnom Valley and na dis kind sins di nashons wey dey der before, dey do wey make God drive dem komot di land.
2CH 28:4 E dey offa sakrifice and burn incense for where dem for dey woship juju on-top di hill and for under evry green tree.
2CH 28:5 Di Oga wey bi en God kon gi-am to Siria king. Siria pipol win and karry Judah pipol go Damaskus as prisonas. God still gi-am to Israel king and e kon distroy en kingdom.
2CH 28:6 King Pekah for Israel wey Remalaya born, kill 120,000 sojas for Judah, bikos dem turn from dia grand-grand papa God.
2CH 28:7 One soja for Efraim wey dem dey koll Zikri, kill di king son wey dem dey koll Maaseaya and Azrikam wey dey kare for di palis with Elkanah wey bi di kommander.
2CH 28:8 Israel pipol seize 200,000 wifes, sons and dotas from dia brodas. Dem still karry many of dia tins go Samaria.
2CH 28:9 Oded wey bi God profet, dey der. E go meet di sojas wen dem rish Samaria kon sey, “Si, bikos una grand-grand papa God dey vex with Judah pipol, na-im make am give dem to una. Una don kill dem well-well and God know evritin.
2CH 28:10 But naw, una won turn Judah and Jerusalem pipol to una slave. Una nor know sey dat one na sin against God?
2CH 28:11 Make una listin and send di pipol wey una katch from una brodas land go back, bikos God don dey vex for una!”
2CH 28:12 Zabud wey bi Jehohanan pikin, Berekaya wey Meshillemot born, Jehizkaya wey bi Shallum pikin and Amasa wey Hadlai born kon go meet doz pipol wey dey kom back from war
2CH 28:13 sey, “Make una nor bring doz slave kom here! Una wont make us kommit more sin for God eye? Awa sin don plenty rish and God don dey vex for Israel pipol already.”
2CH 28:14 So for di ofisas and di pipol front, di sojas kon release di slave and all di tins wey dem karry.
2CH 28:15 Dem tell some men make dem find klot from di tins wey dem karry kon give di prisonas wey naked. So dem give dem klot, shoe, food, drink and oil wey dem go take rub dia body. Di ones wey nor fit waka, dem put dem on-top donkey. Dem bring dem back to Jeriko, di Palm Tree Town, den dem kon go back to Samaria.
2CH 28:16 For dat time, King Ahaz kon ask Assyria king make e help am.
2CH 28:17 Edom pipol don fight, win and karry Judah pipol go as slave again.
2CH 28:18 For dis time, Filistia pipol don still go fight Judah towns for di low lands and Negev Valley. Dem take-ova Bet-Shemesh, Aijalon, Gederot and Soko, Timnah, Gimzo and all di towns wey near dem kon stay der.
2CH 28:19 God sofa Judah pipol, bikos of King Ahaz for Israel wey enkourage Judah pipol to sin and disobey God.
2CH 28:20 King Tilgat-Pilneser for Assyria kom, but instead make e support, e kon give dem more trobol.
2CH 28:21 Ahaz gada many tins from God Temple, di palis and di ofisas kon give dem to Assyria, but dat one nor help am.
2CH 28:22 Na wen King Ahaz dey for trobol, e even disobey God pass.
2CH 28:23 E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.
2CH 28:24 Ahaz gada and remove all di tins wey dey God Temple. E lock di temple doors kon make juju altar for evry street for Jerusalem.
2CH 28:25 E make high place for evriwhere make dem dey give juju sakrifice for Judah. E make en grand-grand papa God vex well-well.
2CH 28:26 Di remainin tins wey Ahaz do wen e dey rule, dem rite dem for Judah and Israel kings history book.
2CH 28:27 Ahaz die and dem beri am for David Town, but dem nor beri am for where dem beri Israel kings put. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.
2CH 29:1 Hezekaya na twenty-five years wen e start to rule and e rule twenty-nine years from Jerusalem. Zekaraya pikin, Abijah, na-im bi Hezekaya mama.
2CH 29:2 E obey God, just like David en grand-grand papa do.
2CH 29:3 For di first mont for di first year wen e dey rule, e open God Temple kon ripair di doors.
2CH 29:4 King Hezekaya bring di priest and Levi pipol togeda for di east side for di temple
2CH 29:5 kon tell dem, “Una wey bi Levi pipol, make una listin to mi. Make una dey holy, so dat una go fit make una grand-grand papa dem temple holy! Make una remove anytin wey nor dey klean from God Temple!
2CH 29:6 Awa papa dem nor obey God, dem do wiked tins against awa God kon turn from am. Dem leave and rijet God.
2CH 29:7 Dem lock di temple kon kwensh di lamps; dem nor offa incense or burnt sakrifice for God house and na dis God bi Israel pipol God.
2CH 29:8 Bikos of dis, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol and wetin E do dem dey make evribody shake and fear.
2CH 29:9 Si, awa papa don die for war and dem karry awa wifes and shidren go as prisonas.
2CH 29:10 I won make kovenant with di Oga wey bi Israel pipol God, so dat E nor go vex again.
2CH 29:11 My pipol, make una nor waste time, bikos God don choose una to serve and gi-am sakrifice.”
2CH 29:12 Dis na Levi pipol wey ready to do wetin di king tok: From Kohat shidren-shidren: wi get Mahat wey bi Amasai pikin and Joel wey bi Zabud pikin. From Merari shidren-shidren: wi get Kish wey bi Abdi pikin and Zabud wey Jehallelel born. From Gershon shidren-shidren: wi get Joah wey bi Zimma pikin and Eden wey Joah born.
2CH 29:13 From Elizafan shidren-shidren: wi get Shimri and Jeiel. From Asaf shidren-shidren: wi get Zekaraya and Matanaya.
2CH 29:14 From Heman shidren-shidren: wi get Jehiel and Shimei. From Jedutun shidren-shidren: wi get Shemaya hand Uzziel.
2CH 29:15 Dem gada dia brodas kon santify demsef. Dem kon go inside go klean God Temple, just as di king tok from God word.
2CH 29:16 Di priest enter God house kon make am holy. Evritin wey nor dey klean for God Temple, dem karry am go out and Levi pipol kon karry dem go Kidron Valley.
2CH 29:17 Dem start to klean for di first day for di first mont and for di eight day for di mont, dem klean rish di varanda for God Temple. Dem klean God Temple for anoda eight days kon finish for di sixteent day for di same mont.
2CH 29:18 Dem go meet King Hezekaya kon tell am, “Wi don klean God Temple with evritin wey dey inside: di tabol for di holy bread and di altar wey dem for dey offa sakrifice.
2CH 29:19 Wi don prepare and replace all di tins wey Ahaz komot wen e bi king, bikos e nor dey obey God. Dem dey God altar front naw.”
2CH 29:20 For early morning di next day, King Hezekaya gada all di town ofisas go God Temple.
2CH 29:21 Dem bring seven bulls, seven rams, seven lamb and seven goats to offa as sin ofrin for di kingdom, for God Temple and for Judah pipol. Di king tell di priest wey kom from Aaron family sey make e do sakrifice for God altar.
2CH 29:22 Dem kill di bulls, rams, lamb kon put dia blood for di altar.
2CH 29:23 Den, dem bring di goats for di sin ofrin kon give di king and evribody wey gada, den dem put dia hand on-top di goats.
2CH 29:24 So di priest kill di goats, put dia blood for di altar as sin ofrin to klean Israel pipol, bikos di king don tok am sey di burnt sakrifice and di sin ofrin, na for Israel pipol.
2CH 29:25 Di king follow di advise wey God give King David thru Profet Gad and Profet Natan. E put Levi pipol for di temple with harp and cymbals.
2CH 29:26 Levi pipol karry David music instrument and di priest dem karry dia own trumpet too.
2CH 29:27 King Hezekaya sey make dem burn di sakrifice for di altar and as dem dey burn di sakrifice, dem dey play David music instrument and sing praiz God.
2CH 29:28 All di pipol wey gada, woship God. Some dey sing and di odas dey blow trumpet. Dem do like dis till di sakrifice burn finish.
2CH 29:29 Afta, di king and all di pipol wey dey with am kon bow woship God.
2CH 29:30 King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
2CH 29:31 King Hezekaya tell dem, “Si, una don dey klean for God eye, so make una bring sakrifice and gift kom take tank God for en temple.” Den, evribody wey gada, karry sakrifice and gifts go tank God and anybody wey like to offa sakrifice, dey burn en ofrin.
2CH 29:32 So evritin wey dem sakrifice give God na: 70 bulls, 100 rams and 200 lamb.
2CH 29:33 Dem still bring 600 bulls and 3,000 sheep as sakrifice and na di pipol go chop dis ones.
2CH 29:34 But dem nor get enough priest to kill all di animals. So, Levi pipol wey bi dia brodas kon help dem till di work finish and di priest santify demsef. Levi pipol even santify demsef pass di priest.
2CH 29:35 Dem do many burnt sakrifice with di drink ofrin too kon burn di fat for di peace ofrin.
2CH 29:36 King Hezekaya and all di pipol happy well-well for wetin God do for dem, bikos E kwik-kwik do am.
2CH 30:1 King Hezekaya send message go Israel and Judah kon rite leta go give Efraim and Manasseh pipol sey make dem kom God Temple for Jerusalem kon celebrate di Passova to take honor di Oga wey bi Israel pipol God.
2CH 30:2 Di king, en ofisas and Jerusalem pipol kon choose to do di Passova for di sekond mont.
2CH 30:3 Dem nor fit dey do am always, bikos many of di priest neva fit santify diasef and di pipol neva gada for Jerusalem.
2CH 30:4 Di king and all di pipol like di plan.
2CH 30:5 So, dem send message go evriwhere for Israel; from Beersheba go rish Dan kon koll all di pipol sey make dem kom do Israel pipol God, Passova Feast for Jerusalem, bikos dem neva koll all di nashon kon do am before, just as dem rite am for di law.
2CH 30:6 Di messenja give evribody for Israel and Judah, di king and di ofisas leta. Wetin di king rite for di leta na, “My pipol Israel, make una turn back kom meet Abraham, Isaak and Israel God, so dat E go kom meet una wey E save from Assyria kings.
2CH 30:7 Make una nor bi like una papa wey nor dey obey dia grand-grand papa God wey make am vex distroy dem and una know evritin.
2CH 30:8 Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.
2CH 30:9 If una turn back kom meet God, doz wey karry una relashon go prison, go pity and free dem. Di Oga una God dey sorry for pipol and if una turn back kom meet am, E nor go rijet una.”
2CH 30:10 Di messenja waka from one town to anoda and e go evriwhere for Efraim and Manasseh land, e even rish Zebulun, but di pipol kon dey laf am.
2CH 30:11 But some men from Asher, Manasseh and Zebulun honbol demsef kon go Jerusalem.
2CH 30:12 God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.
2CH 30:13 Many pipol gada for Jerusalem for di sekond mont make dem celebrate di bread wey nor get yist feast.
2CH 30:14 Dem remove di juju and incense altars from Jerusalem kon trow dem for Kidron Valley.
2CH 30:15 Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di sekond mont. Di priest and Levi pipol kon dey shame for diasef, so dem go God Temple go klean demsef kon offa burnt ofrin.
2CH 30:16 Dem stand for dia difren pozishon, just as God savant Moses rite for en law. As Levi pipol give di blood to di priests, dem kon sprinkol am for di temple.
2CH 30:17 Many pipol wey gada neva santify demsef, so Levi pipol kill di Passova lamb for all di pipol wey nor dey klean and wey nor fit make holy sakrifice for God.
2CH 30:18 Many pipol wey kom from Efraim, Manasseh, Issakar and Zebulun nor dey klean, but dem still disobey kon chop di Passova food as di law tok. King Hezekaya kon pray for dem sey, “Make Oga God wey dey good, forgive
2CH 30:19 evribody wey won follow God wey bi en grand-grand papa God, even doh dem nor dey klean as dem rite am for di temple law.”
2CH 30:20 God hear King Hezekaya prayer kon forgive di pipol.
2CH 30:21 Israel pipol wey gada for Jerusalem celebrate di bread wey nor get yist feast for seven days with joy. Di priests and Levi pipol dey praiz God evriday with all dia heart.
2CH 30:22 King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.
2CH 30:23 Di pipol kon sey make dem celebrate for anoda seven days, so dem kon celebrate for anoda seven days.
2CH 30:24 King Hezekaya give di pipol 1,000 bulls and 7,000 sheep. Di ofisas still give dem 1,000 bulls and 10,000 sheep. Many priest santify diasef too.
2CH 30:25 All di pipol wey gada for der na: Judah pipol, di priests, Levi pipol and strenjas wey dey stay Israel and Judah land.
2CH 30:26 Di party for Jerusalem big pass anytin wey don happen for Jerusalem, since wen Solomon wey bi David pikin, bi king.
2CH 30:27 Di priest and Levi pipol stand up kon bless di pipol and God ansa dia prayers from en throne for heaven.
2CH 31:1 Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.
2CH 31:2 King Hezekaya put priest and Levi pipol sey make dem dey burn sakrifice, serve, give ofrins, tank, praiz and dey woship God for en temple.
2CH 31:3 Di king give some of en animals as burnt sakrifice, with di morning and evening burnt sakrifice and di sakrifice wey dem dey burn for Sabat Day, New Moon and any oda time wey dem rite for God Law Book.
2CH 31:4 E give orda sey make di pipol for Jerusalem bring dia own part wey dem go share give di priest and Levi pipol, so dat dem go obey God kommand.
2CH 31:5 Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.
2CH 31:6 Israel and Judah pipol wey dey stay Judah towns bring one from evry ten melu and sheep, with one from evry ten holy tins wey dem get, so dat dem go dey klean for God eye. Wetin dem bring plenty well-well.
2CH 31:7 For di third mont, dem kon gada all wetin dem bring till di sevent mont.
2CH 31:8 Wen King Hezekaya with en ofisas si wetin dem gada, dem praiz God kon bless di pipol.
2CH 31:9 Wen King Hezekaya ask di priest and Levi pipol about wetin dem gada,
2CH 31:10 Zabud from Zadok family wey dey head all di priests kon sey, “Since dem bigin bring all dis tins kom God Temple, wi dey get plenty to chop and e dey remain. God don bless en pipol, naim make all dis ones still remain.”
2CH 31:11 King Hezekaya give orda make dem prepare store room for di temple. As dem do am finish,
2CH 31:12 dem kon take all di tins, di tithe and di holy tins enter inside. Kenanaya wey kom from Levi, naim bi oga for dis tins and na en broda Shimei dey help am.
2CH 31:13 Jehiel, Azazaya, Nahat, Asahel, Jerimot, Jozabad, Eliel, Ismakaya, Mahat and Benaya dey work under Kenanaya and en broda Shimei wey bi di oga for God Temple, bikos na so King Hezekaya and Zabud wey bi oga for di temple, wont make e bi.
2CH 31:14 Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
2CH 31:15 For di town wey priests dey stay, Eden, Mijamin, Jeshua, Shemaya, Amaraya and Shekanaya dey help Kore share di tins give di oda priests akordin to dia work and age.
2CH 31:16 Dem share give di men wey don old pass thirty years wey dem rite dia name put for di family rekord and doz wey go enter God Temple go serve and do dia evriday work.
2CH 31:17 Dem share di tins give di priests akordin to dia family name for di rekord kon give Levi pipol wey don rish and pass twenty years, akordin to di work wey dem give dia group.
2CH 31:18 Dem share food give all di family wey dem rite for di history book, plus di small shidren, wifes, sons and dotas. Bikos all dis ones dey always santify demsef.
2CH 31:19 Dem choose some men from di priests from Aaron shidren-shidren towns, so dat dem go share di food give all di priests and doz for Levi family rekord.
2CH 31:20 For Judah, King Hezekaya do only tins wey dey rite, korrect and good for God eye.
2CH 31:21 Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.
2CH 32:1 Afta King Hezekaya do all dis good tins for God, King Sennakerib for Assyria with en sojas kon go attack Judah.
2CH 32:2 Wen King Hezekaya si sey Sennakerib don enter and e won attack Jerusalem,
2CH 32:3 e go meet en advise and en sojas oga kon tell dem sey make dem stop di wota for outside di town and dem support am.
2CH 32:4 Many pipol gada go stop di wota make e for nor flow go outside di town again and dem kon sey, “Why Assyria king go kom find wota for here?”
2CH 32:5 King Hezekaya use all en pawa take build di wall wey dem break. E build towa and wall for outside kon fence David Town round. E make many weapons and shields.
2CH 32:6 E put di sojas under dia offisa, den e gada dem for di town gate. E make dia heart strong wen e sey,
2CH 32:7 “Make una dey strong! Make una nor fear or shake, bikos of Assyria king and en sojas, bikos di Pesin wey dey with us, strong pass di pipol wey dey with am.
2CH 32:8 Na only human being pawa dem get, but di Oga wey bi awa God dey with us and E go help us fight all awa war.” So, wetin King Hezekaya tok kon make di sojas get strong heart.
2CH 32:9 Wen King Sennakerib and en sojas still dey for Lakish, e send dis message go give King Hezekaya and all Judah pipol wey dey with am for Jerusalem:
2CH 32:10 Dis na wetin King Sennakerib for Assyria tok, “Why una get heart kon still dey Jerusalem wen sojas surround evriwhere?
2CH 32:11 King Hezekaya tell una sey, ‘Di Oga wey bi awa God go save us from Assyria king pawa.’ But e dey deceive una and honga for food and wota go kill una.
2CH 32:12 Na King Hezekaya skata all God place and altars kon tell Judah and Jerusalem pipol make dem burn incense and woship God for only one altar.
2CH 32:13 Una nor know wetin mi and my grand-grand papa dem do to oda nashons? All di oda land gods fit save en pipol from my pawa?
2CH 32:14 Any of doz kountry gods don fit save dem from my pawa?
2CH 32:15 Make una nor let King Hezekaya deceive una like dis. Make una nor bilive am, bikos no god for any kingdom don fit save en pipol from my hand or my grand-grand papa dem pawa. So, how una God go take save una from my hand?”
2CH 32:16 King Sennakerib savants still insult di Oga God and Hezekaya wey bi God savant.
2CH 32:17 E rite leta kon curse di Oga wey bi Israel pipol God sey: “Di gods for all di nashons nor fit save dia pipol from my pawa. Even King Hezekaya God nor go fit save en pipol from my pawa.”
2CH 32:18 Di ofisas shaut with Hibru language make Jerusalem pipol wey dey di wall, fear run komot, so dat dem go fit seize di town.
2CH 32:19 Dem dey tok about Jerusalem God like sey na one ordinary pesin for di nashon.
2CH 32:20 King Hezekaya and Profet Isaya wey bi Amos pikin kon pray and kry to God.
2CH 32:21 God kon send angel go kill all di soja, prince and offisa for Assyria. So, King Sennakerib kon shame go back to en town. Den wen e go en god temple, en sons kon kill-am with swod.
2CH 32:22 God save King Hezekaya and Jerusalem pipol from King Sennakerib and di oda nashons. E protet dem for evry side.
2CH 32:23 Many pipol bring tins kon give God for Jerusalem and dem still give betta gifts to King Hezekaya for Judah. From dat time go, all di nashons kon dey respet am.
2CH 32:24 For dat time, one kind bad sickness katch King Hezekaya. E pray give God and God show am sign sey, e go well.
2CH 32:25 But King Hezekaya nor dey honbol again, bikos e kon dey karry body wey make God vex for both en, Judah and Jerusalem pipol.
2CH 32:26 King Hezekaya and Jerusalem pipol kon turn kom meet God and E forgive dem again.
2CH 32:27 King Hezekaya get money well-well and pipol dey respet am. E build where dem go dey keep en silva, gold, precious stones, spices and many oda tins wey e get, put.
2CH 32:28 E still build store for en rice wey dem harvest, en wine, olive oil and for en plenty animals.
2CH 32:29 E build royal towns and e get many sheep and melu, bikos God gi-am many propaty.
2CH 32:30 King Hezekaya block where wota from dey kom on-top Gihon kon direct am go di west side for David Town. So, God kon bless King Hezekaya for evritin wey e do.
2CH 32:31 Wen Babilon ofisas send pipol go find out about di sign wey happen for di land, God kon leave di king alone, so dat E go fit test am, make E for know wetin dey en mind.
2CH 32:32 Di remainin good tins wey Hezekaya do, dem rite dem for di book wey bi Profet Isaya wey Amos born, own. Dem still rite dem for Judah and Israel kings history book.
2CH 32:33 Hezekaya die and dem beri am for David shidren-shidren grave. Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem beri am with honor. En pikin Manasseh kon take-ova as king.
2CH 33:1 Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule for fifty-five years from Jerusalem.
2CH 33:2 E sin like di oda kings and nashons wey God porshu komot di land for Israel pipol.
2CH 33:3 E build di high place wey en papa King Hezekaya skata. E make altars for Baal and Asherah juju. E bow and woship all di stars for di sky.
2CH 33:4 Manasseh build altars for God Temple, di place where God for sey, “Jerusalem go bi my house forever.”
2CH 33:5 For di two kourtyard for God Temple, e build altars for all di stars for di sky.
2CH 33:6 E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.
2CH 33:7 Di juju image wey e make, e put am for God Temple, di place wey God tell David and Solomon en pikin sey, “Dis temple for Jerusalem, na-im I don choose among Israel land, as my house forever.
2CH 33:8 I nor go make Israel pipol leave di land wey I give dia grand-grand papa again, as long as dem dey obey di kommand, laws and rules wey I give dem thru Moses, my savant.”
2CH 33:9 But Manasseh deceive Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem make dem for sin pass di nashons wey God distroy komot der, for dem.
2CH 33:10 Even as God warn Manasseh and en pipol rish, dem nor gri listin.
2CH 33:11 So God kon allow di oga for Assyria sojas attack Judah. Dem seize Manasseh, hook en nose, tie am with bronze shains kon karry am go Babilon.
2CH 33:12 As dem dey sofa am, Manasseh kon turn go meet God wey bi en grand-grand papa God sey make E kon help am.
2CH 33:13 Wen e pray to God, God hear and ansa en kry for help. God bring am kom back to Jerusalem wey bi en kingdom. Den Manasseh kon know sey na di Oga bi di true God.
2CH 33:14 Afta dis, Manasseh build di outside wall for David Town for di west side for Gihon Valley go rish di Fish Gate and di oda gates. E make am high well-well kon put sojas for evriwhere for di town wey dem fence for Judah.
2CH 33:15 E remove all di juju and image dem from God Temple. All di altars wey e build for di hill for God Temple and for Jerusalem, e trowey dem.
2CH 33:16 E build God altar kon offa peace and tanksgivin ofrin. E tell Judah pipol make dem serve Israel God wey bi di true God.
2CH 33:17 Di pipol still dey offa sakrifice for di high place, but na only to dia Oga wey bi God.
2CH 33:18 Di remainin tins wey Manasseh do, with how e pray to God and di profesy wey dem use God name take tell am, dem rite dem put for Israel kings history book.
2CH 33:19 Wetin dem rite for di profets book still get: en prayers and how God take ansa am; all en sins and di bad tins wey e do; where e build high place with Asherah juju before e turn to Oga God.
2CH 33:20 Manasseh die and dem beri am for en palis. En pikin Amon kon take-ova as king.
2CH 33:21 Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule for two years from Jerusalem.
2CH 33:22 E nor obey God just as Manasseh en papa bin do. E do sakrifice for all di juju wey en papa make.
2CH 33:23 Amon nor respet di Oga wey bi God, just as Manasseh en papa take leta respet am. E even sin pass en papa.
2CH 33:24 En savants plan kon kill-am for en palis.
2CH 33:25 But di pipol kill doz wey plan against Amor, den Josaya wey bi Amon pikin, dem kon make am king.
2CH 34:1 Josaya na eight years wen e start to rule and e rule for thirty-one years from Jerusalem.
2CH 34:2 E do wetin God wont kon follow David wey bi en grand-grand papa footstep, e nor turn go left or rite.
2CH 34:3 For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju.
2CH 34:4 E give orda sey make dem distroy Baal juju kon skata di incense altar wey dey on-top dem. E skata and grind Asherah juju, di oda juju and dia image, den e pour dia dust on-top di juju savant graves.
2CH 34:5 E burn di juju priest bones for di altars where dem for dey woship before. Bikos of all dis tins wey e do, Judah and Jerusalem kon dey holy again.
2CH 34:6 E do di same tin for Manasseh, Efraim and Simeon land go rish Naftali and all di towns wey dey near dem.
2CH 34:7 E distroy di altar, Asherah juju and di oda juju kon skata all di incense altars wey dey for Israel town, den e go back to Jerusalem.
2CH 34:8 For di eighteent year wen e dey rule, e kontinue to dey make di land and di temple holy. King Josaya tell Shafan wey Azalaya born, Maaseaya wey bi Jerusalem govnor and Joah wey bi di high offisa Jehoahaz pikin sey, “Make una go ripair di Oga awa God, temple.”
2CH 34:9 Di money wey Levi pipol wey dey guide don kollect for di temple, dem pak and gi-am to Hilkaya wey bi di High Priest. (Dem kollect am from Manasseh, Efraim and all di pipol wey remain for Israel, Judah, Benjamin and Jerusalem.)
2CH 34:10 Dem kon give di money to di three men wey dey ripair di temple wey
2CH 34:11 leta give di karpenters and doz wey dey build, so dat dem go use am take buy strong stones and timba, to take ripair di house wey Judah kings bin skata.
2CH 34:12 Di men work with all dia mind and di four Levi men wey dey supavise dem na: Jahat and Obadaya from Merari; Zekaraya and Meshullam from Kohat family. (All Levi pipol wey dey der, sabi sing well-well.)
2CH 34:13 Oda Levi pipol still dey supavise difren works, while some na guards and ofisas.
2CH 34:14 Wen dem remove di silva wey dem bring kom God Temple, Priest Hilkaya kon si di Law Book wey God give Moses.
2CH 34:15 Priest Hilkaya tell Shafan. “I don si di Law Book for God Temple.” Den e give di book to Shafan.
2CH 34:16 Shafan take di book go give di king kon sey, “Yor savants dey do evritin wey dem give dem.
2CH 34:17 Dem melt di silva for God Temple kon gi-am to doz wey dey supavise dia work.”
2CH 34:18 Shafan still tell di king, “Na Priest Hilkaya give mi dis book.” Den Shafan shaut as e dey read wetin dey di book give di king.
2CH 34:19 Wen di king hear di words wey dem rite for di Law Book, e kon tear en klot.
2CH 34:20 Di king sey make Priest Hilkaya orda Ahikam wey bi Shafan pikin; Abdon wey Mikah born; Shafan wey bi di seketry and Asaya wey bi di king savant sey:
2CH 34:21 “Make una go pray give God for mi and di pipol wey remain for Judah and Israel. Den ask am about di words wey dey dis book wey dem si, bikos God dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor obey en word as dem rite am for dis book!”
2CH 34:22 So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.) Dem kon tell di woman evritin wey happen,
2CH 34:23 den di woman sey, “Make una go tell di king,
2CH 34:24 ‘God sey: “I go ponish Jerusalem and all di pipol with di curse dem wey dey inside dis book wey dem read gi-am.
2CH 34:25 Dem don rijet mi kon dey sakrifice give oda gods, so I dey vex for wetin dem do. I dey vex naw for Jerusalem and nor-tin go fit stop mi make I nor ponish dem.” ’
2CH 34:26 And for di king ensef, dis na wetin di Oga God dey tok: ‘Yu don listin to evritin wey dem rite for dis book
2CH 34:27 and yu kom turn from sin kom meet mi, as yu tear yor klot dey kry wen yu hear sey I won ponish Jerusalem with en pipol. I don hear una prayer.
2CH 34:28 So, I go let una die make dem beri una with peace. Una nor go si di wahala wey I won bring kom Jerusalem.’ ” So dem kon go tell di king dis tins.
2CH 34:29 Di king koll all di leaders for Judah and Jerusalem
2CH 34:30 kon gada di pipol, di priest, Levi pipol; both old and yong pipol go God Temple and e shaut read wetin dem rite for di Law Book wey dem si for di temple.
2CH 34:31 Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.
2CH 34:32 E make all di pipol wey dey Jerusalem and Benjamin gri sey dem go do am. Pipol for Jerusalem follow di Oga wey bi dia grand-grand papa God kon obey en kovenant.
2CH 34:33 King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.
2CH 35:1 Josaya celebrate God Passova for Jerusalem. Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di first mont.
2CH 35:2 E enkourage di priests kon sey make dem do dia work well for di temple.
2CH 35:3 E still tell Levi pipol wey bi tisha for Israel about di tins wey dem dedikate give God sey, “Di holy ark wey Solomon, King David pikin build, make una put am for di temple. Make una nor put am for una shoulder. So, di Oga wey bi una God, na-im and en pipol Israel, una go serve!
2CH 35:4 Make una arrange unasef akordin to una family, just as King David for Israel and en pikin Solomon tell una.
2CH 35:5 “Make una stand for God house, with di oda Levi pipol and una go ripresent all Israel pipol.
2CH 35:6 Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”
2CH 35:7 Josaya give di pipol 30,000 lamb and goats with 3,000 melu from en animals for di Passova sakrifice.
2CH 35:8 En ofisas still use dia mind give di pipol, di priest and Levi pipol some tins too. Priest Hilkaya, Zekaraya and Jehiel wey bi leaders for di temple, give dem 2,600 lamb and yong goats and 300 melu for di Passova.
2CH 35:9 Kenanaya and en brodas, Shemaya and Netanel with Hashabaya, Jeiel and Jozabad wey bi Levi pipol ofisas, give Levi pipol 5,000 lamb and 500 melu for di sakrifice.
2CH 35:10 Wen dem don arrange evritin for di Passova, di priest and Levi pipol kon stand, take dia pozishon, just as di king tell dem.
2CH 35:11 Dem kill di Passova lambs, den di priest sprinkol di blood for evriwhere. Na Levi pipol prepare di animals.
2CH 35:12 Den dem divide di burnt ofrin among di pipol akordin to dia family, so dat dem go fit offa dem akordin to di kommand wey Moses give dem.
2CH 35:13 Levi pipol roast di Passova lambs just as dem rite am for di Law Book kon boil di holy ofrin inside pots, kettol and pans, den serve di food give all di pipol.
2CH 35:14 Afta, dem prepare sometin for diasef and for di priests, bikos di priests wey bi Aaron shidren-shidren, offa burnt sakrifice with di fat till evening.
2CH 35:15 Doz wey dey play music with Asaf shidren-shidren face dia own pot, just as King David tok thru Profet Asaf, Heman and Jedutun. Di guards nor komot from dia pozishon, bikos Levi pipol prepare sometin for dem too.
2CH 35:16 Dat day, dem prepare evritin to take woship God kon celebrate di Passova, den dem burn sakrifice for God altar, just as King Josaya kommand.
2CH 35:17 So Israel pipol for der kon use seven days take celebrate di Passova with di bread wey nor get yist, feast.
2CH 35:18 Dem neva do dis kind Passova for Israel since Profet Samuel die. No king for Israel don celebrate Passova like di way King Josaya, di priests, Levi pipol, Israel pipol, Judah pipol and all doz wey dey stay for Jerusalem, celebrate am.
2CH 35:19 Dem celebrate dis Passova for di eighteent year wen King Josaya dey rule.
2CH 35:20 Afta King Josaya don do all dis tins for di temple, King Neko for Egypt kon go fight with Karkemish for Eufrates River and Josaya kon go try to stop am.
2CH 35:21 King Neko send messenjas go meet am sey, “Judah King! Wetin make yu dey oppoz mi? I nor dey attack yu, na di kingdom wey I follow get war I kom meet and God sey make I hurry. God dey my side, so make yu nor oppoz mi or God go distroy yu.”
2CH 35:22 But King Josaya nor hear word, bikos e don ready ensef for war. E nor listin to wetin King Neko tok at-all, so e kon go fight am for Megiddo Hill.
2CH 35:23 Egypt sojas kon shot King Josaya as dem dey fight, so di king tell en savants, “Make una karry mi komot for here, bikos I don wound well-well.”
2CH 35:24 So, en savants karry am for anoda shariot go Jerusalem where e for die. Dem beri am for en grand-grand papa grave and all di pipol for Judah and Jerusalem, kry well-well.
2CH 35:25 Profet Jeremaya sing one song for King Josaya and e don turn tradishon for doz wey dey sing for Israel and na both man and woman dey use di song wen dem dey mourn. Dem add di song join di oda mourning songs.
2CH 35:26 Di remainin good tins wey King Josaya do as dem rite am for God law book,
2CH 35:27 with all di tins wey e gain, from biginnin go rish end, dem rite dem for Israel and Judah kings history book.
2CH 36:1 Di pipol for di land take Josaya pikin Jehoahaz kon make am king for Jerusalem.
2CH 36:2 Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule three monts from Jerusalem.
2CH 36:3 King Neko for Egypt take am go prison kon sey make Judah pipol pay 7,500 pounds for silva and 75 pound for gold as tax to am.
2CH 36:4 Egypt king kon make Eliakim wey bi Jehoahaz broda king for Judah and Jerusalem and dem shange en name to Jehoiakim. King Neko karry Jehoahaz go Egypt.
2CH 36:5 Jehoiakim na twenty-five years wen dem make am king and e rule eleven years from Jerusalem. E do wiked and bad tins before God.
2CH 36:6 King Nebukadnezzar for Babilon attack Jehoiakim, use bronze take shain am kon karry am go Babilon.
2CH 36:7 King Nebukadnezzar take some of di tins wey dey God Temple go Babilon kon put dem for en palis.
2CH 36:8 Di remainin tins wey Jehoiakim do wen e dey rule, all di big-big sins and bad tins wey e do, dem rite dem for Israel and Judah kings history book. En pikin Jehoiashin kon take-ova as king.
2CH 36:9 Jehoiashin na eighteen years wen e start to rule and e rule three monts and ten days from Jerusalem. E nor gri obey God.
2CH 36:10 Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
2CH 36:11 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule eleven years from Jerusalem.
2CH 36:12 E do wiked and bad tins for God eyes. E nor honbol ensef to Profet Jeremaya wey bi God savant.
2CH 36:13 King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God.
2CH 36:14 All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.
2CH 36:15 God wey bi dia grand-grand papa God always dey warn dem, bikos E dey pity for en pipol and Jerusalem wey bi en house.
2CH 36:16 But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.
2CH 36:17 E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.
2CH 36:18 Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.
2CH 36:19 Dem burn God Temple kon skata Jerusalem wall. Dem burn all di towns wey dem fence kon distroy all dia betta-betta tins.
2CH 36:20 Di king karry all di pipol wey e nor kill go Babilon as slave and dem serve en and en shidren till Persia kingdom start to reign.
2CH 36:21 So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”
2CH 36:22 To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.
2CH 36:23 Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ”
EZR 1:1 For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:
EZR 1:2 Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.
EZR 1:3 Make God dey with all of una wey bi en pipol as una dey go Jerusalem go ribuild di Oga wey bi Israel God house and na-im una go woship for Jerusalem.
EZR 1:4 Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.
EZR 1:5 Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
EZR 1:6 All dia neighbours give dem tins like gold, silva pot, food, animals, oda betta tins and ofrin wey dem go use take ribuild God Temple.
EZR 1:7 King Cyrus bring di basins and cups wey King Nebukadnezzar take from God Temple for Jerusalem kon put dem for en own gods temple.
EZR 1:8 E give dem to Mitredat, di oga wey dey hold di palis money and e kount evritin give Sheshbazzar wey bi di govnor for Judah.
EZR 1:9 Di tins wey e kount na: 30 gold basin and 1,000 silva basin for ofrin and 29 oda basin.
EZR 1:10 Di oda tins na 30 small gold basin, 410 small silva basin and di oda tins to take kook, na 1,000.
EZR 1:11 Evritin kon bi 5,400 gold, silva and oda tins and Sheshbazzar karry dem follow body as en and di pipol dey komot from Babilon go Jerusalem.
EZR 2:1 Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.
EZR 2:2 Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:
EZR 2:3 Parosh family na 2,172,
EZR 2:4 Shefataya family na 372,
EZR 2:5 Arah family na 775,
EZR 2:6 Pahat-Moab (Jeshua and Joab shidren-shidren) na 2,812,
EZR 2:7 Elam family na 1,254,
EZR 2:8 Zattu family na 945,
EZR 2:9 Zakkai family na 760,
EZR 2:10 Bani family na 642,
EZR 2:11 Bebai family na 623,
EZR 2:12 Azgad family na 1,222,
EZR 2:13 Adonikam family na 666,
EZR 2:14 Bigvai family na 2,056,
EZR 2:15 Adin family na 454,
EZR 2:16 Ater (wey kom from Hezekaya family), en family na 98,
EZR 2:17 Bezai family na 323,
EZR 2:18 Jorah family na 112,
EZR 2:19 Hashum family na 223,
EZR 2:20 Gibbar family na 95.
EZR 2:21 Betlehem men na 123,
EZR 2:22 Netofat men na 56,
EZR 2:23 Anatot men na 128,
EZR 2:24 Azmavet men na 42,
EZR 2:25 Kiriat-Jearim, Kefirah and Beerot men na 743,
EZR 2:26 Rama and Gibeah men na 621,
EZR 2:27 Mikmash men na 122,
EZR 2:28 Bethel and Ai men na 223,
EZR 2:29 Nebo family na 52,
EZR 2:30 Magbish family na 156,
EZR 2:31 Di oda family for Elam na 1,254,
EZR 2:32 Harim family na 320,
EZR 2:33 Lod, Hadid and Ono men na 725,
EZR 2:34 Jeriko men na 345,
EZR 2:35 Hassenaah family na 3,630.
EZR 2:36 Dis na di list of di priests family wey kom back from Babilon: Jedaya (wey bi Jeshua shidren-shidren) and dem bi 973,
EZR 2:37 Imma family na 1,052,
EZR 2:38 Pashhur family na 1,247,
EZR 2:39 Harim family na 1,017.
EZR 2:40 Levi family wey kom back from Babilon na: Jeshua and Kadmiel (wey bi Hodevah shidren-shidren) na 74.
EZR 2:41 Di temple muzicians (wey bi Asaf shidren-shidren) na 128.
EZR 2:42 Di temple guards (wey bi Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren) na 139.
EZR 2:43 Di pipol wey dey work for di temple, wey kom back from Babilon, dia family na: Ziha, Hasufa, Tabbaot,
EZR 2:44 Keros, Siaha, Padon,
EZR 2:45 Lebanah, Hagabah, Akkub,
EZR 2:46 Hagab, Shamlai, Hanan,
EZR 2:47 Giddel, Gahar, Reaaya,
EZR 2:48 Rezin, Nekoda, Gazzam,
EZR 2:49 Uzza, Paseah, Besai,
EZR 2:50 Asnah, Meunim, Nefusim,
EZR 2:51 Bakbuk, Hakufa, Harhur,
EZR 2:52 Bazlut, Mehida, Harsha,
EZR 2:53 Barkos, Sisera, Temah
EZR 2:54 Nezaya and Hatifa.
EZR 2:55 Solomon savants families wey kom back from Babilon na: Sotaya, Hassoferet, Peruda,
EZR 2:56 Jaalah, Darkon, Giddel,
EZR 2:57 Shefataya, Hattil, Pocheret-Hazrebaim and Ami.
EZR 2:58 All di pipol wey dey work for di temple and Solomon savant shidren-shidren wey kom back, na 392.
EZR 2:59 Dis na di ones wey kom from Tel-Melah, Tel-Harsha, Kerub, Addon and Imma (aldo dem nor fit show weda dem really kom from Israel tribe), di family na:
EZR 2:60 Delaaya, Tobaya and Nekoda shidren-shidren and dem bi 652.
EZR 2:61 Dis na some among di priests family wey dem nor fit show sey dem bi Israel pipol: Hobaaya, Hakkoz, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin and e kon dey ansa en fada-in-law name.)
EZR 2:62 Since dem nor fit prove who dia grand-grand papa bi, dem nor kon asept dem as priest.
EZR 2:63 So di govnor tell dem sey dem nor go fit chop di food wey dem offa give God, until di land don get priest wey go use Urim and Tummim.
EZR 2:64 Di total pipol wey kom back from Babilon na 42,360.
EZR 2:65 Even doh dem nor kount di men and wimen savant, dem still bi 7,337 wey kom back. Di men and wimen muzicians na 200.
EZR 2:66 Horse na 736, melu na 245,
EZR 2:67 Kamels na 435 and donkey na 6,720.
EZR 2:68 Wen di pipol rish God Temple for Jerusalem, some among di leaders for each family drop ofrin from dia mind make dem join am take ribuild God Temple for Jerusalem.
EZR 2:69 Dem give di amount wey dem fit give for di work and di total na: 61,000 pounds for gold, 5,000 pounds for silva and 100 garment for di priests.
EZR 2:70 Di priests, Levi pipol and some of di pipol, di singas, di temple guards and di temple workers stay for di town wey dey near Jerusalem; while di remainin Israel pipol stay for di towns wey dia grand-grand papa stay before.
EZR 3:1 For di sevent mont wey Israel pipol don dey stay for dia towns, all of dem kon gada for Jerusalem
EZR 3:2 and Jeshua wey Jehozadak born, en fellow priests, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin and en family membas kon build di Oga wey bi Israel God altar back, so dat dem go fit dey burn sakrifice for der akordin to wetin dem rite for God savant, Moses Law.
EZR 3:3 Even doh di pipol wey kom back from Babilon dey fear doz wey dey di land, dem still build di altar put for where e dey before. So dem start to burn di normal morning and evening sakrifice for der.
EZR 3:4 Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa
EZR 3:5 with di regular sakrifice, both for di New Moon Festival and di oda feast to take woship God. Di pipol dey still give ofrin to God from dia mind.
EZR 3:6 Aldo di pipol neva start to ribuild di temple, but dem start to burn sakrifice give God for di first day for di sevent mont.
EZR 3:7 So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.
EZR 3:8 So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work.
EZR 3:9 Jeshua wey kom from Levi tribe, en sons and family membas, Kadmiel and en sons (wey bi Hodevah family) join ribuild di temple. (Henadad family wey bi Levi pipol, help dem too.)
EZR 3:10 Wen di men start di temple foundashon, di priests wear dia garment, stand for dia pozishon kon hold dia trumpet for hand. Levi pipol wey kom from Asaf family still stand der too with dia cymbals. Dem praiz God akordin to wetin dem rite down for King David time.
EZR 3:11 Dem sing praiz God sey: God dey good and en love for Israel nor dey end. Evribody kon bigin shaut praiz God with all dia pawa, bikos dem don start work for di temple.
EZR 3:12 Many of di priests, Levi pipol and di head for each family wey bin si di first temple kon dey kry well-well as dem start to ribuild di temple. But di odas dey happy.
EZR 3:13 Nobody know who dey happy or kry, bikos di nois wey dem dey make, loud well-well and dem dey hear am from far.
EZR 4:1 Wen Judah and Benjamin enemies hear sey doz wey kom back from Babilon, dey ribuild di Oga wey bi Israel God Temple,
EZR 4:2 dem go meet Zerubabel and di leaders kon tell dem, “Make una allow us join una ribuild di temple. Bikos wi dey woship di same God wey una dey woship and wi dey offa sakrifice to am ever since King Esarhaddon for Assyria send us kon stay here.”
EZR 4:3 Den Zerubabel, Jeshua and di leaders kon tell dem, “Wi nor nid una help to ribuild di Oga awa God Temple. Wi go build am by awasef, just as King Cyrus for Persia sey make wi do.”
EZR 4:4 Den di pipol wey dey stay di land before won kon try to diskorage and put fear for Judah pipol mind, so dat dem nor go build di temple.
EZR 4:5 Dem still go bribe Persia ofisas, so dat dem go attack Judah pipol. Dem kontinue to dey do like dis thru-out di time wey Cyrus dey rule and dem do am enter King Darius time.
EZR 4:6 Wen King Zazes start to rule, Judah enemies wey dey stay for Judah and Jerusalem kon go komplain against dem.
EZR 4:7 And wen King Atazazes dey rule for Persia, Bishlam, Mitredat, Tabeel and some pipol wey dey follow dem, rite leta go give di king. Dem rite di leta for Aramaik language, but dem go tok di meaning wen dem dey read am.
EZR 4:8 Rehum too wey bi di govnor and Shimshai, di aria seketry kon rite dis leta about Jerusalem go give King Atazazes sey:
EZR 4:9 “From Rehum wey bi di govnor and Shimshai di aria seketry; from di judge dem and all di ofisas from Erech, Babilon and Shushan wey dey Elam land,
EZR 4:10 with di pipol wey di great and pawaful Ashurbanipal karry from dia town go stay Samaria and West Eufrates aria.
EZR 4:11 “(Dis na wetin dem rite for di leta) To King Atazazes and from en savants, di pipol for West Eufrates.
EZR 4:12 Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.
EZR 4:13 Awa oga, if dem build dis town back kon komplete di wall, di pipol go stop to pay tax and di money wey yu dey get for di palis bag, nor go rish again.
EZR 4:14 Naw, bikos of di way wi dey loyal to yu, wi nor won si sey anybody disrespet di king, so wi dey sugest sey,
EZR 4:15 make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town.
EZR 4:16 So wi bilive sey, if dem build di town back kon komplete di wall, awa oga nor go fit kontrol West Eufrates aria again.”
EZR 4:17 Di King kon ansa dem: “To Rehum di govnor; Shimshai di aria seketry; doz wey dey stay Samaria and di remain part for West Eufrates: I dey greet una.
EZR 4:18 Dem don translate and read di leta wey una send kon give mi and
EZR 4:19 I don orda sey make dem find out and dem sey, na true sey Jerusalem dey go against royal authority before; na so-so trobol dem dey find and pipol wey nor dey obey di law, full der.
EZR 4:20 Kings wey get pawa don rule for der before and dem rule di whole West Eufrates aria, dey kollect tax and oda money.
EZR 4:21 So, make una stop to ribuild di town until I kommand make dem build am again.
EZR 4:22 Naw, make una go do wetin I tok, so dat my kingdom go get peace.”
EZR 4:23 As soon as dem just read di leta wey King Atazazes send go give Rehum, Shimshai and di pipol, dem kon rush go Jerusalem go force and stop Jew pipol to ribuild di town.
EZR 4:24 So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.
EZR 5:1 Dat time, two profet wey dia name bi Haggai and Zekaraya wey Iddo born kon start to prish with Israel God name give Jew pipol wey dey stay for Judah and Jerusalem.
EZR 5:2 Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.
EZR 5:3 At wons, govnor Tattenai for West Eufrates, Shetar-Bozenai and dia ofisas kom Jerusalem kon ask: Who orda una sey make una start to ribuild dis temple and komplete am?
EZR 5:4 Dem still ask, Di pipol wey help una dey ribuild dis temple so, wetin bi dia names?
EZR 5:5 But God dey with Jew leaders, so Persia leaders nor kon do anytin until dem rite go give King Darius kon hear wetin e go tok.
EZR 5:6 Dis na di ripot wey dem send go give di king:
EZR 5:7 “To King Darius, make peace dey yor kingdom.
EZR 5:8 Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.
EZR 5:9 So wi ask dia leaders sey, Who orda una make una ribuild di temple and komplete am?
EZR 5:10 Wi still ask for names, so dat wi go fit tell yu di pipol wey dey lead dem do di work.
EZR 5:11 But dem ansa, Wi bi God for heaven and eart savants and wi dey ribuild di temple wey one pawaful king for Israel build before.
EZR 5:12 But bikos awa grand-grand papa dem make God for heaven vex, E kon allow King Nebukadnezzar for Babilon, wey dey rule Kaldean kingdom, attack and distroy di temple kon karry di pipol go Babilon as prisonas.
EZR 5:13 Den for di first year wen King Cyrus dey rule for Babilon, e kon orda sey make wi go ribuild di temple.
EZR 5:14 E riton di gold and silva tins (wey Nebukadnezzar take from di temple for Jerusalem go put for en own temple for Babilon). King Cyrus riton di tins give one man wey dem dey koll Sheshbazzar, wey e choose as govnor for Judah.
EZR 5:15 Di king sey make e put di tins back for di temple for Jerusalem and ribuild di temple for where e bin dey.
EZR 5:16 So Sheshbazzar kon lay di foundashon and na since den wi don dey ribuild, but wi neva fit finish am.
EZR 5:17 Naw, awa oga, if yu like, make yu orda for di royal rekord for Babilon weda yu go si if King Cyrus really give orda sey make dem ribuild di temple for Jerusalem and den, make yu tell us wetin yu si for dis matter.”
EZR 6:1 So King Darius kon orda sey make dem go search di royal rekord wey dem keep for Babilon.
EZR 6:2 But na for Ekbatana town for Media aria naim dem for si one book wey get dis rekord:
EZR 6:3 For di first year wen King Cyrus dey rule, e kommand sey make dem ribuild di temple for Jerusalem as di place where dem for go dey offa sakrifice and burnt ofrin. E sey, make di temple high and wide rish ninty-nine fit.
EZR 6:4 Make dem build di wall with one layer and make wood dey on-top each layer. Na di pesin wey dey keep di royal money, go pay for evritin.
EZR 6:5 Make dem still riton all di gold and silva tins wey King Nebukadnezzar karry from di temple for Jerusalem kom Babilon. Make dem put dem for God temple, di place where dem dey before.
EZR 6:6 Den King Darius ansa: To Tattenai, di govnor for West Eufrates, Shetar-Bozenai and una ofisas for der, make una nor go near di temple
EZR 6:7 and nor tok as dem dey build am. Make una allow di govnor for Judah and di leaders ribuild God Temple as e bi before.
EZR 6:8 I kommand una naw sey, make una help dem ribuild di temple. Di palis go use di tax wey dem kollect from West Eufrates take pay for evritin, so dat nor-tin go stop di work.
EZR 6:9 Una must give di priest for Jerusalem anytin wey dem tell una sey dem wont: yong melu, sheep or lamb wey dem go burn as ofrin give di Oga God wey dey heaven or even if na wheat, salt, wine or olive oil dem nid for dia ofrin.
EZR 6:10 Una must give dem dis tins, so dat dem go fit offa sakrifice wey God wey dey heaven go asept and pray make E bless mi and my sons.
EZR 6:11 So, I kommand sey if any of una nor obey dis orda, dem go komot one wood pila from en house, sharp one side, den take am shuk di pesin die. And dem go turn di house to where dem dey trowey dirty put.
EZR 6:12 Make di God wey choose Jerusalem as di place where dem go for woship am ova-trow any king or nashon wey nor obey dis kommand or won try distroy di temple. Mi, Darius don kommand and una must obey my kommand go rish di end.
EZR 6:13 Den govnor Tattenai, Shetar-Bozenai and dia ofisas kon do evritin wey di king kommand.
EZR 6:14 Jew leaders kon dey progress well-well as dem dey build di temple, wey profet Haggai and Zekaraya enkourage dem to build. Dem komplete di temple, just as Israel God, King Cyrus, King Darius and King Atazazes for Persia kommand sey make dem do.
EZR 6:15 Dem finish di temple for di third day for Adar mont (First mont) for di sixt year wen King Darius dey rule.
EZR 6:16 Den Israel pipol, di priests, Levi pipol and all di oda pipol wey kom back from Babilon kon dedikate di temple with joy.
EZR 6:17 For di dedikashon, dem offa 100 melu, 200 sheep and 400 lamb as sakrifice and 12 goat as ofrin for sin, one for each tribe for Israel.
EZR 6:18 Dem still arrange di priests and Levi pipol wey go dey serve for di temple for Jerusalem, just as dem rite am for Moses Law.
EZR 6:19 Di pipol wey kom back from Babilon celebrate Passova for di fourteent day for di first mont.
EZR 6:20 All di priest and Levi pipol kon santify demsef. Levi pipol kill di animals wey dem use for di Passova sakrifice for evribody wey kom back from Babilon; for di priests and for demsef.
EZR 6:21 Den Israel pipol wey kom back, chop di sakrifice with doz wey don stop to serve di juju wey di pipol wey dey di land before, dey serve. All of dem kon woship di Oga wey bi Israel God.
EZR 6:22 Dem happy well-well as dem dey celebrate di Bread wey nor get Yist Feast, for seven days. Belle sweet dem well-well, bikos God shange Assyria king karata and e kon support dem as dem dey ribuild Israel God Temple.
EZR 7:1 Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa.
EZR 7:2 Na Shallum born Hilkaya. Zadok wey Ahitub born, na-im bi Shallum papa.
EZR 7:3 Na Amaraya born Ahitub and na Zabud bi Amaraya papa. Na Meraiot born Zabud.
EZR 7:4 Zerahaya wey bi Uzzi pikin, na-im bi Meraiot papa. Bukki born Uzzi,
EZR 7:5 and na Abishua wey Finehas born bi Bukki papa. Eleazar wey bi Aaron pikin, na-im bi Finehas papa.
EZR 7:6 Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.
EZR 7:7 For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.
EZR 7:8 Dem komot from Babilon for di first day for di first mont
EZR 7:9 and with God help, dem rish Jerusalem for di first day for di fift mont.
EZR 7:10 Ezra main work na to dey study God law, pratise am and tish Israel pipol how to obey God.
EZR 7:11 King Atazazes give dis leta to Ezra wey bi priest, wey sabi read and know evritin about di law and kommand wey God give Israel pipol:
EZR 7:12 From Atazazes wey bi king of all kings to Priest Ezra wey know God for heaven law well-well: I greet yu.
EZR 7:13 I dey kommand sey for evriwhere for my kingdom, make Israel pipol, priests, Levi pipol and doz wey like to go, follow yu go Jerusalem.
EZR 7:14 Mi and my seven advisers dey send yu go shek wetin dey happen for Jerusalem and Judah and to si weda dem dey obey yor Oga God law wey dey yor hand.
EZR 7:15 Yu go take di gold and silva ofrin follow body, bikos na mi and my seven advisers won gi-am to Israel God, wey en temple dey Jerusalem.
EZR 7:16 Make yu still take all di gold and silva wey yu fit kollect from Babilon and di ofrin wey Israel pipol and dia priests give for dia Oga God Temple for Jerusalem.
EZR 7:17 Yu must spend di money well kon buy bulls, rams, lamb, korn and wine, den make yu offa dem for di altar for di temple wey dey Jerusalem.
EZR 7:18 Yu fit use di silva and gold wey remain take do wetin yu and yor kountry-men like, so-far na as God wont am.
EZR 7:19 Make yu show yor pipol evritin wey wi give yu, so dat dem go gi-am to God for di temple for Jerusalem.
EZR 7:20 Yu fit still kollect anytin wey yu wont for di temple from di palis propaty.
EZR 7:21 I kommand sey make all di ofisas wey dey keep money for West Eufrates aria provide for Priest Ezra wey know God for heaven law. Make una give dem
EZR 7:22 7,500 silva pound, 100 bags for wheat, 100 gallon for wine, 100 gallons for olive oil and plenty salt.
EZR 7:23 Yu must do evritin wey God for heaven wont for en temple kon make sure sey, E nor ever vex for mi and doz wey go rule afta mi.
EZR 7:24 Nor kollect any tax from di priests, Levi pipol, muzicians, guards or doz wey dey work for di temple.
EZR 7:25 As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.
EZR 7:26 Make dem ponish anybody wey nor obey yor God law or di law for di kingdom: dem go kill or porshu di pesin komot from di town. Dem fit seize en propaty or put am for prison.
EZR 7:27 Ezra kon sey, Make wi praiz di Oga, wey bi awa grand-grand papa dem God! Na-im make di king honor God Temple for Jerusalem like dis.
EZR 7:28 E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.
EZR 8:1 Dis na di leaders wey bi prisonas for Babilon and wey follow Ezra go back to Jerusalem, wen Atazazes bi king:
EZR 8:2 Gershom from Finehas family; Daniel from Itama family; Hattush (Shekanaya pikin) from David family;
EZR 8:3 Zekaraya from Parosh family with 150 men from en family (dem get di rekord about dis family);
EZR 8:4 Zerahaya pikin, Eliehoenai from Pahat-Moab family, with 200 men;
EZR 8:5 Jahaziel pikin, Shekanaya from Zattu family, with 300 men;
EZR 8:6 Jonatan pikin, Ebed from Adin family, with 50 men;
EZR 8:7 Atalaya pikin, Jeshaya from Elam family, with 70 men;
EZR 8:8 Mikael pikin, Zebadaya from Shefataya family, with 80 men;
EZR 8:9 Jehiel pikin, Obadaya from Joab family, with 218 men;
EZR 8:10 Josifaya pikin, Shelomit from Bani family, with 160 men;
EZR 8:11 Bebai pikin, Zekaraya from Bebai family, with 28 men;
EZR 8:12 Hakkatan pikin, Johanan from Azgad family, with 110 men;
EZR 8:13 Elifelet, Jeiel and Shemaya from Adonikam family, with 60 men (dis pipol leta go meet Ezra for Jerusalem);
EZR 8:14 Utai and Zakkur, from Bigvai family, with 70 men.
EZR 8:15 I gada dem for di river wey dey rush go Ahava Town and wi stay der for three days. I si sey some priests dey among di pipol, but Levi pipol nor dey.
EZR 8:16 I kon sey make dem go koll nine leaders kom and dem bi: Elieza, Ariel, Shemaya, Elnatan, Jarib, Elnatan, Natan, Zekaraya and Meshullam and two tishas wey bi Joiarib and Elnatan.
EZR 8:17 I send dem go meet Iddo, di kommunity leader wey dey Kasifaya, make dem ask en and en ofisas, doz wey dey work for di temple, so dat dem go send some pipol kom wey go serve God for di temple.
EZR 8:18 Bikos di good God hand dey with us, dem kon send Sherebaya, one strong man from Levi tribe for Mahli family and 18 of en sons and brodas follow am kom.
EZR 8:19 Dem still send Hashabaya and Jeshaya, from Merari family, with 20 of dia relashon.
EZR 8:20 Di total kon bi 220 temple workers wey King David and en ofisas choose dia grand-grand papa to help Levi pipol. Dem rite all dia name down.
EZR 8:21 For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.
EZR 8:22 I dey shame to ask di king make e give us some sojas wey go guide us from awa enemies as wi dey travel, bikos I tell am sey, Awa God dey bless anybody wey trust am, but E dey ponish and vex with anybody wey turn from am.
EZR 8:23 So wi fast and pray make God protet us and E ansa awa prayers.
EZR 8:24 Den I choose Sherebaya and Hashabaya and ten oda pipol among di priest wey dey lead.
EZR 8:25 So I measure di gold, di silva and di oda tins wey di king, en advisers, ofisas and Israel pipol give make dem use for di temple kon give dem to di priests.
EZR 8:26 Dis na wetin I give: 650 silva, 100 silva kishin tins, 100 gold koin,
EZR 8:27 20 gold bowls wey heavy rish 1,000 gold koin, 2 fine bronze bowls wey dear like one gold bowl.
EZR 8:28 Den I tell dem, “Bikos una dey holy to God, wey bi una grand-grand papa God, na so too all di gold and silva tins wey dem bring kon gi-am as ofrin, must dey holy.”
EZR 8:29 So make una guide dem with kare until una rish di temple. If una rish di priest room, make una measure dem kon give dem to di priests, Levi pipol, Israel and Jerusalem leaders.
EZR 8:30 So di priests and Levi pipol kon karry di silva, gold and di oda tins, go di temple for Jerusalem.
EZR 8:31 Na for di twelft day for di first mont naim wi komot from Ahava River kon start to go Jerusalem. Awa God dey with us and E protet us from enemies make dem nor attack and set trap for us as wi dey travel.
EZR 8:32 Wi rest for three days, wen wi rish Jerusalem.
EZR 8:33 Den wi kon go di temple for di fourt day, measure di gold, silva and di oda tins kon gi-am to Priest Meremot wey Uriaya born. Eleazar wey bi Finehas pikin and two Levi pipol; Jozabad wey Jeshua born and Noadaya wey Binnui born, dey der with am.
EZR 8:34 Dem measure and kount evritin and dem get di komplete rekord at wons.
EZR 8:35 All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.
EZR 8:36 Dem still take di dokument wey di king give dem kon gi-am to di govnors and ofisas wey dey West Eufrates aria and dem too kon dey support di pipol and God Temple.
EZR 9:1 Afta dem don do all dis tins finish, some among Israel leaders kom meet and tell mi, Di pipol, di priest and Levi pipol neva separate demsef from di pipol wey dey di kountries wey near dem. Dem still dey do tins with Ammon, Moab, Egypt, Kanaan, Hit, Periz, Jebus and Amor pipol. Dem dey do di same yeye tins wey doz pipol dey do.
EZR 9:2 Jew men dey marry wimen wey bi strenjas, so dem don dirty God pipol wey dey holy and na di leaders and ofisas dey do dis tins pass.
EZR 9:3 Wen I hear dis tins, I vex tear my klot, kut my hair and bear-bear kon sidan for groun dey mourn.
EZR 9:4 Den all di pipol wey dey respet and fear God word kon sidan with mi too bikos of di bad tin wey di pipol do. I sidan der kon dey mourn until wen dem won do di evening sakrifice.
EZR 9:5 Wen di time don rish for di evening sakrifice, I get up from where I sidan, but I still wear my tear-tear klot kon knee down, stresh my hand to di Oga my God kon pray.
EZR 9:6 I sey, My Oga God, I dey shame to raiz my head for yor front. Awa sins high pass awa head; dem even high rish heaven.
EZR 9:7 From awa grand-grand papa time kon rish naw, wi wey bi yor pipol don sin well-well. Na bikos of awa sin, wi, awa kings and priests, fall for strenj kings hand and dem kill, tif and karry us go as prisonas. Dem don disgrace us well-well as wi dey today.
EZR 9:8 “But naw, for dis short time, awa Oga God, Yu don trit us well kon stop some of us to bi slave and wi dey live for peace for dis Holy Place. Yu don remove us from slave work kon give us new life.
EZR 9:9 Even doh wi bi slave before, Yu nor leave us as slave. Yu make Persia king favor us kon allow us go ribuild yor temple wey skata and make wi wey dey Judah and Jerusalem get peace.
EZR 9:10 But naw, awa God, wetin wi fit tok afta evritin wey don happen? Wi don disobey di kommand
EZR 9:11 wey Yu give us thru yor savants di profet. Dem tell us sey di land wey wi go stay nor dey klean, bikos di pipol wey dey stay der, dey do many-many dirty tins.
EZR 9:12 Dem tell us sey if wi won stay der for peace and leave am for awa shidren-shidren forever, make wi nor marry doz pipol or help dem prosper.
EZR 9:13 Even afta di ponishment wey don happen to us bikos of awa sin, wi still know sey Yu, awa God, dey sorry for us, bikos even doh Yu dey ponish us, Yu still help us survive am.
EZR 9:14 So, how wi go forget yor kommand again kon go marry doz wiked pipol? If wi do am, Yu go vex kon distroy us finish and nobody go survive.
EZR 9:15 Awa Oga wey bi Israel God, Yu dey good. Wi, yor savants wey remain, kom meet Yu and wi dey konfess awa sins. Aldo wi nor get any rite to kom yor present again afta evritin wey wi don do.”
EZR 10:1 Wen Ezra dey pray, kry and konfess all dis sins for di temple front, many pipol, both men, wimen and shidren stand round kon join am dey kry.
EZR 10:2 Den Shekanaya wey bi Jehiel pikin wey kom from Elam family kon tell Ezra, “Wi nor dey faithful to God, bikos wi go marry doz strenj wimen, but even with dat, Israel still get hope.
EZR 10:3 Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand.
EZR 10:4 So make yu get up, bikos na yor rite to take akshon. Wi dey yor back, so go do as yu fit sey God wont.”
EZR 10:5 So Ezra get up kon make di leaders among di priests, Levi pipol and all Israel pipol swear sey dem go do anytin wey Shekanaya tok.
EZR 10:6 Den e get up from di temple front kon enter Jehohanan wey bi Eliashib pikin room. E dey der thru-out dat nite dey kry for di pipol sin. E nor chop or drink anytin.
EZR 10:7 Den, dem kon send message go evriwhere for Jerusalem and Judah sey make evribody wey kom back from Babilon gada for Jerusalem.
EZR 10:8 Anybody wey nor kom before three days finish, dem go seize all en propaty and e go luz en rite as memba for di kommunity.
EZR 10:9 Before di days finish, for di twenteth day for di ninet mont, all di pipol wey dey stay for Judah and Benjamin aria kom gada for Jerusalem for di temple front. Heavy rain dey fall, so evribody kon dey fear, bikos of di weda and di matter wey make dem gada.
EZR 10:10 Priest Ezra stand up kon tell dem, “Una don kommit strong sin as una go marry doz wimen wey bi strenjas. Una don add join Israel wahala.
EZR 10:11 Naw, make una konfess una sins give di Oga wey bi una grand-grand papa God kon start to do wetin go make belle sweet am. Make una separate unasef from doz strenjas wey dey for awa land and drive all una wife wey nor kom from Israel tribe.”
EZR 10:12 So di pipol shaut ansa, “Wi go do anytin wey yu tok.
EZR 10:13 And dem still sey, Di crowd too many and heavy rain dey fall. Wi nor go fit stand for outside like dis. Dis nor bi wetin wi go fit finish for one or two days, bikos wi many wey kommit dis sin.
EZR 10:14 Make awa leaders handle di matter. Den make doz wey marry woman from anoda kountry, kom gada with di leaders and judge dem for di town for di time wey dem gri sey make wi meet, until God nor go dey vex for us again.”
EZR 10:15 Nobody tok against dis plan escept Jonatan wey Asahel born; Jahzeaya wey bi Tikvah pikin and Meshullam and Shabbetai wey bi Levi, dey support dem too.
EZR 10:16 Di pipol wey kom back from Babilon asept di plan, so Priest Ezra kon choose some men from among di leaders den rite dia names down. So dem sidan togeda for di first day for di tent mont kon tok about di matter
EZR 10:17 and for di first day for di first mont, dem judge all di men wey marry wimen from anoda kountry.
EZR 10:18 Dis na di names of di men wey marry wimen from anoda kountry: From di priests akordin to dia family: From Jeshua and en brodas Jehozadak family: Maaseaya, Elieza, Jarib and Gedalaya.
EZR 10:19 Dem promise sey dem go divorce dia wifes and dem offa ram as sakrifice for dia sins.
EZR 10:20 From Imma family: Hanani and Zebadaya.
EZR 10:21 From Harim family: Maaseaya, Elijah, Shemaya, Jehiel and Uzzaya.
EZR 10:22 From Pashhur family: Elioenai, Maaseaya, Ishmael, Netanel, Jozabad and Eleasah.
EZR 10:23 From Levi family: Jozabad, Shimei, Kelaya (wey dem still dey koll Kelita), Petahaya, Judah and Elieza.
EZR 10:24 Doz wey dey sing: Eliashib. Di temple guards na: Shallum, Telem and Uri.
EZR 10:25 Odas name na: From Parosh family: Ramaya, Izzaya, Malkijah, Mijamin, Eleazar, Makijah and Benaya.
EZR 10:26 From Elam family: Matanaya, Zekaraya, Jehiel, Abdi, Jerimot and Elijah.
EZR 10:27 From Zattu family: Elioenai, Eliashib, Matanaya, Jerimot, Zabad and Aziza.
EZR 10:28 From Bebai family: Jehohanan, Hananaya, Zabbai and Atlai.
EZR 10:29 From Bani family: Meshullam, Malluk, Adaya, Jashub, Sheal and Jerimot.
EZR 10:30 From Pahat-Moab family: Adna, Kelal, Benaya, Maaseaya, Matanaya, Bezalel, Binnui and Manasseh.
EZR 10:31 From Harim family: Elieza, Isshaya, Malkijah, Shemaya, Simeon
EZR 10:32 Benjamin, Malluk and Shemaraya.
EZR 10:33 From Hashum family: Mattenaya, Matatta, Zabad, Elifelet, Jeremai, Manasseh and Shimei.
EZR 10:34 From Bani family: Maadai, Amram, Uel,
EZR 10:35 Benaya, Bedeaya, Keluhi
EZR 10:36 Vanayah, Meremot, Eliashib
EZR 10:37 Matanaya, Mattenaya and Jaasu.
EZR 10:38 From Binnui family: Shimei,
EZR 10:39 Shelemaya, Natan, Adaya,
EZR 10:40 Maknadebai, Shashai, Sharai,
EZR 10:41 Azarel, Shelemaya, Shemaraya,
EZR 10:42 Shallum, Amaraya and Josef.
EZR 10:43 From Nebo family: Jeiel, Mattitaya, Zabad, Zebina, Jaddai, Joel and Benaya.
EZR 10:44 Na all dis men marry wimen from anoda kountry. Dem divorce dem kon porshu dem and dia shidren kom from Israel.
NEH 1:1 Dis na di tins wey Hakalaya pikin, Nehemaya do. For di twenteth year, for Kislev mont, wen Atazazes bi king for Persia, mi, Nehemaya, dey Shushan, wey bi di palis.
NEH 1:2 Dat time, one among my brodas wey en name na Hanani, kom from Judah with some oda men, so I ask dem about Jerusalem town and awa pipol wey go back to Jerusalem from Babilon.
NEH 1:3 Dem kon tell mi, “Tins hard for di pipol wey kom back. Dem dey for big trobol and disgrace. Dem neva fit ribuild Jerusalem wall and di gate wey awa enemies burn, still dey groun.”
NEH 1:4 Wen I hear all dis tins, I sidan kry well-well and I nor chop for many days. Den I pray to God sey,
NEH 1:5 “Oga God for heaven! Yu big well-well and wi dey fear Yu. God wey keep en promise with doz wey love and dey do wetin E kommand.
NEH 1:6 My Oga God, make Yu look mi kon hear my prayers for yor savants, Israel pipol, both for day and nite. I konfess sey wi, Israel pipol don sin. Wi and awa grand-grand papa dem don sin.
NEH 1:7 Wi don do many wiked tins against Yu and wi nor do wetin Yu kommand sey make wi do. Wi nor keep di laws wey Yu give us thru yor savant Moses.
NEH 1:8 Make Yu remember wetin Yu tell Moses wen Yu sey, ‘If una nor dey faithful to mi, I go skata una go oda nashons.
NEH 1:9 But if una turn back from una sin kom meet mi and do wetin I kommand una, I go bring una kom di place wey I don choose sey una go for woship mi, even doh una skata for evriwhere for dis world.’
NEH 1:10 My God, dis pipol na yor savants and pipol. Na Yu save dem with yor great pawa.
NEH 1:11 Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
NEH 2:1 Den for Nisan mont for di twenteth year wen King Atazazes dey rule. As e dey chop, I go gi-am wine and bikos e neva si my face like dat before,
NEH 2:2 e kon ask, “Why yor face bi like who dey sick even doh yu nor sick? Dis one mean sey yu nor dey happy!” I kon bigin fear
NEH 2:3 so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”
NEH 2:4 Den di king ask, “Na wetin yu wont naw?” So I kwik-kwik pray to God wey dey heaven,
NEH 2:5 den I ansa, “If my king dey happy with mi and go gri do wetin I wont, den make yu allow mi go Judah town, where dem beri my grand-grand papa dem put, so dat I go fit ribuild am.”
NEH 2:6 Di king and en wife wey sidan near am kon agri. Den e ask mi how many days I go stay, before I go kom back. So I kon tell am.
NEH 2:7 I still beg am make e give mi letas, make I give di govnors for West Eufrates aria, so dat dem go allow mi travel well pass dia aria until I rish Judah.
NEH 2:8 I still ask di king make e give mi leta wey I go give Asaf wey dey guide di royal forest, so dat e go give mi big-big woods make I take build di guide gate for di temple, di town wall and di house wey I go stay. So di king give mi all wetin I wont, bikos God dey with mi.
NEH 2:9 As I dey go West Eufrates, di king send some soja oga and horse-men follow mi. For der, I kon give di king letas to di govnors.
NEH 2:10 But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.
NEH 2:11 I kon go Jerusalem and for three days,
NEH 2:12 I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
NEH 2:13 Day neva break well wen I leave di town kon pass thru di Valley Gate for west go di sout-side, den I pass Dragon Well go di Dirty Gate. As I dey go, I dey look all di wall wey don break for di town and di gates wey fire distroy.
NEH 2:14 For di east side for di town, I pass nort go di Well Gate and di King Pool. Di donkey wey I dey ride nor si enough space to pass,
NEH 2:15 so I kom down go Kidron Valley as I still dey look di wall dem. Den I pass di Valley Gate, go back to di town.
NEH 2:16 Di ofisas nor know where I from dey kom or wetin I go do, bikos I nor tok anytin to my fellow Jew pipol, di priests, di leaders, di ofisas or any oda pesin wey go join do di work.
NEH 2:17 Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”
NEH 2:18 I tell dem how God help and dey with mi. I still tell dem evritin wey di king tell mi. Di pipol ansa, “Make wi start to ribuild di wall!” So dem kon ready to start di work.
NEH 2:19 Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”
NEH 2:20 I ansa dem, “God wey dey heaven go give us viktory. Wi bi en savants and wi go start to build. But una nor get rite, share or anytin to klaim for Jerusalem.”
NEH 3:1 Eliashib wey bi di high priest and en oda priests build di Sheep Gate, dedikate kon put di doors as dem suppose dey. Dem build go rish di Hundred Towa and Hananel Towa kon dedikate dem too.
NEH 3:2 Jeriko men build di next part. And Zakkur wey bi Imri pikin build di next one.
NEH 3:3 Hassenaah sons build di Fish Gate, dem fix di doors, en bolts and bars.
NEH 3:4 Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part. While Meshullam wey Meshezabel pikin Berekaya born, do di next part. Na Zadok, wey Baanah born, ripair di oda part.
NEH 3:5 Tekoa men do di next part wey dem give dem, but some among di leaders for di town nor gri do di work wey dia oga give dem to do.
NEH 3:6 Joiada wey bi Paseah pikin with Meshullam wey Besodeaya born kon ripair Jeshanah Gate. Dem fix di doors, en bolts and bars.
NEH 3:7 Melataya wey kom from Gibeon, Jadon wey kom from Meronot, Gibeon men and Mizpa kon ripair di next part go rish West Eufrates govnor side.
NEH 3:8 Uzziel wey bi Harhaya pikin, wey dey melt gold kon ripair di next part. Hananaya wey dey make perfume, ripair di next side go rish di Broad Wall.
NEH 3:9 Refaaya wey Hur born, wey dey rule half of Jerusalem aria kon ripair di next part.
NEH 3:10 Na Jedaya wey bi Harumaf pikin, ripair di side wey dey near en own house. Hattush wey Hashabneaya born, ripair di next side.
NEH 3:11 Malkijah wey Harim bi en papa with Hasshub wey bi Pahat-Moab pikin kon ripair di next part and Ovens Towa.
NEH 3:12 Shallum wey Hallohesh born, wey bi ruler for di oda half of Jerusalem aria, ripair di next part and en dotas help am for di work.
NEH 3:13 Hanun and di pipol wey dey stay Zanoah aria, ripair di Valley Gate. Dem ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars. Dem still ripair di wall wey bi 1,500 fit wey lead to di Dirty Gate.
NEH 3:14 Na Malkijah wey bi Rekab pikin, wey bi ruler for Bet-Hakkerem aria, ripair di Dirty Gate. E ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars.
NEH 3:15 Shallum pikin, Kol-Hozeh, wey bi ruler for Mizpa aria, ripair di Well Gate. E ribuild and roof am, kon fix di doors, en bolts and bars. For Siloam Pool, near di royal gardin, e still ripair di wall go rish di road wey lead to David Town.
NEH 3:16 Nehemaya wey bi Azbuk pikin, wey dey rule half of Bet-Zur aria, ripair di next side go rish David Grave, with di pool and di Sojas House.
NEH 3:17 Levi pipol wey ripair di next parts na, Rehum wey bi Bani pikin, while Hashabaya wey dey rule half of Keilah aria, ripair di next part for en aria pipol.
NEH 3:18 Na Binnui wey bi Henadad pikin, wey dey rule di oda half of Keilah aria, ripair di next part.
NEH 3:19 Ezer wey bi Jeshua pikin, wey bi ruler for Mizpa, ripair di next part for armoury front, go rish di place where di wall for turn.
NEH 3:20 Baruk wey Zabbai born, ripair di next part go rish where dem dey pass enter Eliashib di high priest house.
NEH 3:21 Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part go rish di end for Eliashib house.
NEH 3:22 Na all di priests from di aria wey dey near der, ripair di rest part for di wall.
NEH 3:23 Benjamin and Hasshub, ripair di next part wey dey front of dia house. Zabud wey Ananaya pikin Maaseaya born, ripair di next part wey dey en house front.
NEH 3:24 Na Binnui wey bi Henadad pikin ripair di next part, from Zabud house go rish di wall korna.
NEH 3:25 Na Palal wey bi Uzai pikin, ripair di next part from di wall korna and di towa for di king uppa house wey near di guards kourt. Afta am, na Pedaaya wey bi Parosh pikin
NEH 3:26 and di temple savants wey dey stay Ofel Hill ripair rish di aria wey dey opposite di Wota Gate for di east side and di towa wey dey guide di temple.
NEH 3:27 Afta dem, Tekoa men ripair anoda part wey dey opposite di big towa, wey guide di temple go rish Ofel wall.
NEH 3:28 Some priests ripair from top of di Horse Gate and each pesin ripair front of en own house.
NEH 3:29 Zadok wey bi Imma pikin, ripair di next part, wey dey front of en house. Shemaya wey Shekanaya born, wey dey guide di East Gate, ripair di next part.
NEH 3:30 Hananaya wey bi Shelemaya pikin with Hanun wey bi Zalaf sixt pikin, ripair di oda part. Afta dem, Meshullam wey bi Berekaya pikin kon ripair di oda side for en house front.
NEH 3:31 Malkijah wey dey melt gold, ripair di next side go rish di temple savants and di tradas house, wey dey near Inspeshon Gate go rish di uppa room for di korna side.
NEH 3:32 Odas wey dey melt gold and di tradas, ripair di last part from di uppa room wey dey korna, go rish di Sheep Gate.
NEH 4:1 Wen Sanballat hear sey, wi Jew pipol don start to dey build di wall, e kon dey vex and laf us.
NEH 4:2 For en friends and Samaria pipol front, e kon sey, “Wetin dis yeye Jew pipol tink sey dem dey do? Dem one build di town again? Dem tink sey, na to offa sakrifice dem go take build di town finish one day? Dem go fit make stones from di ashes of di tins wey fire burn?”
NEH 4:3 Tobaya wey kom from Ammon stand near am kon sey, “Even fit fox waka on-top di wall wey dem build, na wons di wall go fall rish groun!”
NEH 4:4 Den I pray, “My Oga God! Make Yu hear as dem dey laf us. Make dia laf and disgrace fall for dia own head. Make dem tif all di propaty wey dem get kon karry dem as prisonas go strenj land.
NEH 4:5 Make Yu nor forgive di bad-bad tins wey dem do and nor forget dia sins, bikos dem don curse us wey dey build.”
NEH 4:6 So, wi kon kontinue to dey build di wall and bikos di pipol dey ready to work, wi kon almost build am rish half of how e high rish before.
NEH 4:7 Sanballat, Tobaya with Arab, Ammon and Ashdod pipol kon dey vex well-well wen dem hear sey wi still dey ribuild Jerusalem wall and kover all di holes wey dey.
NEH 4:8 So, dem plan to attack and kause wahala for Jerusalem.
NEH 4:9 But wi pray give awa God kon put men wey go dey guide di place both day and nite.
NEH 4:10 Judah pipol get one song wey dem dey sing: “Doz wey dey work, dia pawa don fail! Di trobol too mush and bikos of dat, wi nor fit ribuild di wall.”
NEH 4:11 Awa enemies still sey, “Before dem go si or know wetin dey happen, wi don attack, kill and kause wahala for dem!”
NEH 4:12 So from time to time, Jew pipol wey dey stay among awa enemies, dey kom tell us di plan wey di enemies dey plan.
NEH 4:13 So I give di pipol swod, bow and arrow kon put some pipol for back of di walls and some for open space.
NEH 4:14 I si sey di pipol dey worry, so I kon tell dem, dia ofisas and dia leaders sey, “Make una nor fear awa enemies. Make una remember how great and mighty God bi, den make una fight for una brodas, shidren, wifes and una house.”
NEH 4:15 Awa enemies hear sey wi don know di plan wey dem dey plan against us and dem know sey God don make dia plan fail. Den all of us kon go start to build again.
NEH 4:16 From den go, half among my men dey work and half dey guide, dem wear war klot and hold spears, shields and bows. And di leaders really support di pipol
NEH 4:17 wey dey ribuild di wall. Even doz wey dey karry di tins wey dem take dey work, dey karry am with one hand kon hold swod for di oda hand
NEH 4:18 and evribody wey dey build, hang swod for dia waist. Di man wey go blow di trumpet as signal stand near mi.
NEH 4:19 I tell di pipol and dia ofisas, “Where wi dey work big well-well naim make us dey far from each oda for di wall.
NEH 4:20 So if una hear di trumpet nois, make una gada round mi and awa God go fight for us.”
NEH 4:21 So half dey work from morning go rish nite evriday, while di oda half dey guide.
NEH 4:22 By dis time, I tell di leaders sey dem and di pipol wey dey help dem, must stay for Jerusalem for nite, so dat wi go fit guide di town for nite and work for day time.
NEH 4:23 For dis time, mi, doz wey dey follow mi, my savant and my bodyguards, nor dey shange klot at-all. And all of us keep awa swod, bow and arrow for where wi go kwik take am even fit na wota wi dey drink.
NEH 5:1 Afta sometaim, many among Israel pipol, both men and wimen kon dey komplain about dia own brodas.
NEH 5:2 Some sey, “Wi get big family, so wi nid enough food wey wi go dey chop, so dat wi nor go die.”
NEH 5:3 Odas sey, “Wi don use awa farm, vineyard and house take-take loan, so dat wi go get enough food to chop, make honga nor kill us.”
NEH 5:4 Some odas still sey, “Wi borrow money take pay di royal tax for awa farm and vineyards.
NEH 5:5 Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”
NEH 5:6 I vex well-well wen I hear dia kry and komplain.
NEH 5:7 Afta I tink about am well-well, I kon tok against di ofisas and doz wey get money. I tell dem, “Una dey opress and ponish una own brodas as una dey take intrest wen dem borrow money from una!” Bikos of dem, I kon koll evribody togeda make dem tok for di matter.
NEH 5:8 I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.
NEH 5:9 Den I sey, “Wetin una dey do so nor good! Una nid to respet God and dey do wetin korrect. Den una nor go give awa enemies wey bi Gentile pipol, any shance to laf us.
NEH 5:10 Even mi, my brodas and men dey borrow money and korn give di pipol, but naw, make wi stop dis intrest wey wi dey take from dem.
NEH 5:11 Make una kancel all di debt wey dem dey owe una; weda na money, korn, wine or olive oil kon give dem back dia vineyards, farms, olive farm and house!”
NEH 5:12 Di ofisas and doz wey get money kon ansa, “Wi go do as yu tok. Wi go give dem dia propaty and nor kollect wetin dem dey owe us.” Den I koll di priests kon make di ofisas and doz wey get money swear for dia front, so dat dem go keep di promise wey dem just make.
NEH 5:13 I pul di garment wey I wear kon shake am. Den I sey, “Na so God go take shake any of una wey nor keep en promise. E go distroy una house and evritin wey una get and nor-tin go remain for una.” Evribody wey dey der kon sey, “Amen!” Den dem kon praiz God. And di ofisas and doz wey get money, do wetin dem promise.
NEH 5:14 Na di twenteth year wey Atazazes bi king, e make mi govnor for Judah and since den kon rish naw wey bi di twelft year wey I dey rule Judah (di thirty-two years wey Atazazes don dey rule), mi and my family nor chop di food wey dem suppose dey give mi as govnor.
NEH 5:15 All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.
NEH 5:16 I use all my pawa and money take ribuild di wall and I nor buy any propaty for mysef. Evribody wey dey work for mi, join ribuild di town too.
NEH 5:17 I dey always feed 150 Jew pipol and dia leaders for my house; apart from di strenjas wey dey kom meet mi from di tribes wey surround us.
NEH 5:18 I dey kill one melu, six big sheep and many fawol evriday and evry ten days, I dey provide fresh wine. I nor take di tins wey I suppose take from di pipol as dia govnor, bikos of di heavy work wey dem dey do.
NEH 5:19 So my Oga God, I abeg, make Yu remember evritin wey I don do for dis pipol, den make Yu bless mi.
NEH 6:1 Wen Sanballat, Tobaya, Geshem and di rest of awa enemies hear sey wi don build di wall tight well-well, even doh wi neva set di gates for where dem suppose dey,
NEH 6:2 dem kon send message kom give mi sey make I kom meet dem for one village for Ono field. But I kon know sey dem dey plan to attack mi.
NEH 6:3 So I send message to dem sey, “I get betta work wey I dey do, so I nor go fit kom. I nor go fit stop di work, bikos I won kon si una.”
NEH 6:4 Dem send mi di same message four times and each time dem send am, I dey give dem di same ansa.
NEH 6:5 For di fift time, Sanballat send one savant with leta kon give mi.
NEH 6:6 Dis na wetin dem rite for di leta: “Geshem tell mi sey, dem dey tok for evriwhere sey yu and Jew pipol won kom attack us and na dis make yu dey build di wall back. E still sey yu dey plan to make yorsef king
NEH 6:7 and yu don arrange with some profet make dem announce for Jerusalem sey yu bi Judah king. Naw, di king go hear about am and na dis make mi sey make yu kom make wi first tok about di matter.”
NEH 6:8 I ansa am, “All wetin yu tok so, nor bi true. Na only yu arrange dis story.”
NEH 6:9 I si sey dem dey won make us fear, so dat wi go stop di work. But I pray kon sey, “My Oga God, make Yu give mi strent!”
NEH 6:10 By dis time, I go visit Shemaya wey Mehetabel pikin Delaaya born, wey nor fit komot from en house. Den e tell mi, “Mi and yu must go hide for di Holy Place for di temple kon lock di doors, bikos dem won kon kill yu. Dem go kom kill yu anytime from naw.”
NEH 6:11 I ansa, “I nor bi di kind pesin wey dey run go hide. Yu tink sey I go won save my life kon go hide for di temple? I nor go do am.”
NEH 6:12 Wen I tink am again, I just know sey God nor tok to Shemaya, but na Sanballat and Tobaya bribe am make e for tok wetin e dey tok so.
NEH 6:13 Dem hire am make e for make mi fear den kon sin, so dat dem go spoil and disgrace my good name.
NEH 6:14 I kon pray, “My God, remember wetin Sanballat and Tobaya dey do, den make Yu ponish dem. Remember and ponish dat woman Noadaya and all di oda profets wey dey won make mi fear.”
NEH 6:15 Afta wi don work for fifty-two days, wi finish di hole wall for di twenty-fifth day for Elul (October) mont.
NEH 6:16 Wen awa enemies wey dey di nashons wey surround us hear am, shame katch dem, bikos evribody know sey na God help us do di work.
NEH 6:17 For all dis time, Jew leaders dey rite and receive letas from Tobaya.
NEH 6:18 Many pipol for Judah dey en side, bikos en fada-in-law na Jew wey bi Shekanaya wey bi Arah pikin. En pikin Jehohanan marry Meshullam wey bi Berekaya dota.
NEH 6:19 Pipol go dey tok for my front about all di good tins wey Tobaya dey do kon go tell am evritin wey I tok. But e still kontinue to dey send mi leta wey go make mi fear.
NEH 7:1 Afta wi don ribuild di wall and put all di gates for dia pozishon, I kon give doz wey dey guide di temple, doz wey dey sing for di temple and di oda Levi pipol, di work wey dem go do.
NEH 7:2 I put two men make dem dey kontrol Jerusalem town and dem bi my brodas: Hanani and Hananaya wey dey kommand di strong house dem. Hananaya dey faithful and dey fear God well-well.
NEH 7:3 I tell dem sey make dem nor dey open di gate for morning until aftanoon and make dem dey lock am before di guards go sleep for nite. I still tell dem sey make dem choose guards from among di pipol wey dey stay Jerusalem, make some stand for di gate, while odas go dey go round di aria and dia own house.
NEH 7:4 Jerusalem na big town, but di pipol wey dey stay inside nor plenty and dem neva build all di house finish.
NEH 7:5 God put am for my heart sey make I koll all di pipol, dia leaders and ofisas togeda kon shek dia family rekord. I si di first set wey kom back from Babilon and dis na dia rekord:
NEH 7:6 Dis na di pipol for di aria wey kom back from Babilon since King Nebukadnezzar karry dem go der as prisonas. Dem go back to dia towns for Jerusalem and Judah.
NEH 7:7 Di leaders wey kom back with dem na: Zerubabel, Jeshua, Nehemaya Nahamani, Zabud (Seraya), Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah.
NEH 7:8 Dis na di list of each family for Israel and di nomba of pipol wey from each family kom back from Babilon na: Parosh family wey bi 2,172;
NEH 7:9 Shefataya family and dem bi 372;
NEH 7:10 Arah family and dem bi 652;
NEH 7:11 Pahat-Moab (Jeshua and Joab shidren-shidren) and dem bi 2,818;
NEH 7:12 Elam family and dem bi 1,254;
NEH 7:13 Zattu family and dem bi 845;
NEH 7:14 Zakkai family and dem bi 760;
NEH 7:15 Binnui (Bani) family and dem bi 648;
NEH 7:16 Bebai family and dem bi 628;
NEH 7:17 Azgad family and dem bi 2,322;
NEH 7:18 Adonikam family and dem bi 667;
NEH 7:19 Bigvai family and dem bi 2,067;
NEH 7:20 Adin family and dem bi 655;
NEH 7:21 Ater, (Hezekaya pikin-pikin) family and dem bi 98;
NEH 7:22 Hashum family and dem bi 328;
NEH 7:23 Bezai family and dem bi 324;
NEH 7:24 Harif family and dem bi 112;
NEH 7:25 Gibeon family and dem bi 95.
NEH 7:26 Betlehem and Netofat men na 188;
NEH 7:27 Anatot men na 128;
NEH 7:28 Bet-Azmavet family men na bi 42;
NEH 7:29 Kiriat-Jearim, Kefirah and Beerot men na 743;
NEH 7:30 Rama and Gibeah men na 621;
NEH 7:31 Mikmash men na 122;
NEH 7:32 Bethel and Ai men na 123;
NEH 7:33 Nebo men for west na 52;
NEH 7:34 Elam family for west na 1,254;
NEH 7:35 Harim family na 320;
NEH 7:36 Jeriko family na 345;
NEH 7:37 Lod, Hadid and Ono family na 721;
NEH 7:38 Hassenaah family na 3,930.
NEH 7:39 Di priests family wey kom back from Babilon na: Jedaya (Jeshua shidren-shidren) family and dem bi 973;
NEH 7:40 Imma family na 1,052;
NEH 7:41 Pashhur family na 1,247;
NEH 7:42 Harim family na 1,017.
NEH 7:43 Levi family wey kom back from Babilon na: Jeshua (Kadmiel wey Hodevah en papa, na en shidren-shidren) family and dem bi 74.
NEH 7:44 Doz wey dey sing for di temple (Asaf shidren-shidren) family na 148.
NEH 7:45 Doz wey dey guide di temple (Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren) dia family na 138.
NEH 7:46 Di pipol wey dey work for di temple, dia family wey kom back from Babilon na: Ziha family, Hasufa family, Tabbaot family,
NEH 7:47 Keros family, Sia family, Padon family,
NEH 7:48 Lebanah family, Hagabah family, Shamlai family,
NEH 7:49 Hanan family, Giddel family, Gahar family,
NEH 7:50 Reaaya family, Rezin family, Nekoda family,
NEH 7:51 Gazzam family, Uzza family, Paseah family,
NEH 7:52 Besai family, Meunim family, Nefusim family,
NEH 7:53 Bakbuk family, Hakufa family, Harhur family,
NEH 7:54 Bazlut family, Mehida family, Harsha family
NEH 7:55 Barkos family, Sisera family, Temah family,
NEH 7:56 Nezaya family and Hatifa family.
NEH 7:57 Solomon savants family wey kom back from Babilon na: Sotaya family, Soferet family, Perida family,
NEH 7:58 Jaala family, Darkon family, Giddel family,
NEH 7:59 Shefataya family, Hattil family, Pocheret-Hazrebaim family and Amon family.
NEH 7:60 All di temple savants and Solomon savants shidren-shidren wey kom back na 392.
NEH 7:61 Dis na di ones wey kom from Tel-Melah, Tel-Harsha, Kerub, Addon and Imma (even doh sey dem nor fit show weda dem really kom from Israel tribe):
NEH 7:62 Delaaya family, Tobaya family and Nekoda family and dem bi 642.
NEH 7:63 Dis na some among di priests family wey nor get rekord to show sey dem bi Israel pipol: Hobaaya family, Hakkoz family, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin kon shange en name to en wife papa name) family.
NEH 7:64 Since dem nor fit show who dia grand-grand papa bi, dem nor kon asept dem as priests.
NEH 7:65 So di govnor tell dem sey dem nor go fit chop di food wey dem offa give God, until dem si priest wey go fit use Urim and Tummim.
NEH 7:66 Di total pipol wey kom back from Babilon na 42,360.
NEH 7:67 Dia men and wimen savant na 7,337. Dia men and wimen wey dey sing na 245.
NEH 7:68 Dia horse na 736, melu na 245,
NEH 7:69 Kamels na 435 and dia donkey na 6,720.
NEH 7:70 Some among di leaders for each family kollect ofrin on dia own wey dem join take do di work. Di govnor give 1,000 gold koin, 50 gold basin and 530 garment for di priest.
NEH 7:71 Some among di family leaders give 20,000 gold koin and 2,200 pound for silva.
NEH 7:72 Wetin di remainin pipol give rish, 20,000 pound for gold, 2,000 pound for silva and 67 garment for di priests.
NEH 7:73 Di Priest, Levi pipol, doz wey dey guide di gate, doz wey dey sing, di temple savants and evry oda pesin for Israel kon stay for di town. So for di sevent monts, Israel pipol kon start to stay for dia towns.
NEH 8:1 All of dem gada for Jerusalem for one hall wey dey di Wota Gate front. Dem kon tell Ezra wey sabi di law sey make e go bring di Law Book wey God give Israel thru Moses.
NEH 8:2 So Ezra wey bi priest karry am kom where di pipol gada put, both men, wimen and shidren wey don get sense.
NEH 8:3 E read di law for di hall wey dey near di gate from morning go rish aftanoon and all of dem listin well-well.
NEH 8:4 Ezra stand on-top stage wey dem build, bikos of dis meetin. Di men wey stand for en rite side na: Mattitaya, Shema, Anaya, Uriaya, Hilkaya and Maaseaya, while di men wey stand for en left na: Pedaaya, Mishael, Malkijah, Hashum, Hashbaddanah, Zekaraya and Meshullam.
NEH 8:5 As Ezra stand on-top di stage, all di pipol kon dey look am. All of dem stand up as e just open di book.
NEH 8:6 Ezra kon sey, “Make wi praiz di Oga wey bi di great God!” All di pipol raiz dia hand go up kon ansa, “Amen! Amen!” Dem knee down, bow and woship God.
NEH 8:7 Afta, Levi pipol wey bi: Jeshua, Bani, Sherebaya, Jamin, Akkub, Shabbetai, Hodaya, Maaseaya, Kelita, Zabud, Jozabad, Hanan and Pelaaya kon esplain di law give di pipol wey stand der dey listin.
NEH 8:8 Dem read and esplain God law, so dat di pipol go undastand am.
NEH 8:9 Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.
NEH 8:10 “Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
NEH 8:11 Levi pipol kon go round dey tok to di pipol make dem nor kry, bikos today na holy day.
NEH 8:12 So all di pipol go dia house dey happy, dey chop and drink and share wetin dem get with one anoda, bikos dem undastand wetin dem read give dem.
NEH 8:13 Di next day, di head for each family, with di priests and Levi pipol go meet Ezra wey know di law well-well so dat e go really tish dem.
NEH 8:14 Dem si sey, Moses rite for God Law sey, make Israel pipol stay for shelta wen ever dem dey do di feast for di sevent mont.
NEH 8:15 So dem make and send dis kommand go round Jerusalem and di oda village and towns sey: “Make una go di hills go kut wood kom from olive, myrtle, palm and oda trees make wi take build where wi go stay celebrate di festival, just as dem rite am for di law.”
NEH 8:16 So di pipol go kut palm leaf take kover dia house, di temple kourtyard and di field wey dey near di Wota Gate and Efraim Gate.
NEH 8:17 All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.
NEH 8:18 From di first day wey di festival start go rish di end, dem dey read one-one part from God law evriday. Dem celebrate for seven days kon finish di festival for di eight day, just as dem rite am for di law.
NEH 9:1 For di twenty fourt day, for dat same mont, Israel pipol gada to fast, bikos of sins wey dem kommit.
NEH 9:2 Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.
NEH 9:3 Dem read di Oga dia God law for dem for like three hour, den dem konfess dia sins kon woship di Oga dia God for di next three hours.
NEH 9:4 Den Levi pipol: Jeshua, Binnui, Kadmiel, Shebanaya, Bunni, Sherebaya, Bani and Kenani stand kon shaut pray give di Oga God.
NEH 9:5 Levi pipol: Jeshua, Kadmiel, Bani, Hashabneaya, Sherebaya, Hodaya, Shebanaya and Petahaya kon tell di pipol sey, “Make una stand praiz di Oga una God bikos E dey forever and ever!” Den dem pray sey, “Wi go praiz yor holy name! Make yor name high pass evry blessing and praiz!
NEH 9:6 Na only Yu bi God. Na Yu kreate di heaven and di stars for sky. Yu kreate land, sea and evritin wey dey inside, den kon give dem life. All di pawa for heaven, dey bow woship Yu.
NEH 9:7 Na Yu, Oga God, choose Abram kon lead am komot from Ur for Kaldeans. Na Yu shange en name to Abraham.
NEH 9:8 Na bikos Yu si as e dey faithful rish, naim make Yu make kovenant with am. Yu promise to gi-am Kanaan, Hit, Amor, Periz, Jebus and Girgash pipol land. Di land wey en shidren-shidren go stay and Yu keep yor promise, bikos Yu dey faithful.
NEH 9:9 Yu si as awa grand-grand papa dem sofa for Egypt; Yu hear dem wen dem kry for help for di Red Sea.
NEH 9:10 Yu do wonderful mirakles against Egypt king, en ofisas and dia pipol, bikos Yu know as dem take opress yor pipol. Yu win and give yorsef name wey dem dey celebrate till today.
NEH 9:11 Yu divide di sea for yor pipol kon lead dem pass for dry groun. But Yu make di wota swallow di pipol wey dey porshu dem and dem kon sink like stone.
NEH 9:12 Yu lead yor pipol with kloud for day time and fire wey go dey give dem lite for nite.
NEH 9:13 Yu kom down from heaven kon tok to dem for Mount Sinai; Yu give dem betta judgement, laws, korrect tishings and kommands.
NEH 9:14 Yu tish dem sey make dem keep di Sabat Day holy kon give dem yor laws thru yor savant, Moses.
NEH 9:15 Wen dem dey hongry, Yu give dem bread from heaven and wen dem won drink wota, Yu give dem wota from rock. Yu tell dem sey make dem kontrol di land wey Yu promise to give dem.
NEH 9:16 But bikos of pride and sturbones, awa grand-grand papa dem nor gri obey yor kommand.
NEH 9:17 Dem nor gri obey; dem forget all wetin Yu don do; dem forget di mirakles wey Yu do and bikos of dia pride, dem choose leaders wey take dem go back to Egypt as slave. But Yu bi God wey dey forgive. Yu dey good and dey sorry for pesin. Yu nor dey kwik vex and yor royal love nor dey fail. Yu nor abandon dem at-all
NEH 9:18 even wen dem make juju wey bi like melu kon sey na di god wey lead dem komot from Egypt! Si as dem curse Yu rish!
NEH 9:19 Yet Yu nor still leave dem for inside desert, bikos yor mesi, dey great. Yu nor remove di kloud and fire wey dey show dem lite, both for day and nite.
NEH 9:20 Yu send yor good Spirit make e tell dem wetin dem go do and Yu nor stop to give dem manna chop and wota to drink.
NEH 9:21 For forty years for desert, Yu give dem all wetin dem nid; dem nor wear tear-tear klot and dia leg nor swell-up bikos of pain.
NEH 9:22 Yu make dem win nashons, kingdoms and lands wey dey near dia own. Dem win Heshbon land, wey Sihon dey rule and Bashan land wey Og for bi king.
NEH 9:23 Just as star many for sky, na so di shidren wey Yu give dem many and Yu let dem win and stay for di land wey Yu promise dia grand-grand papa sey Yu go give dem.
NEH 9:24 Dem win Kanaan land; Yu ova-take di pipol wey dey stay der. Yu give yor pipol pawa to do anytin wey dem like with Kanaan pipol and kings.
NEH 9:25 Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.
NEH 9:26 But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,
NEH 9:27 so Yu kon allow dia enemies win and rule dem. But wen dem koll Yu for help wen dem dey trobol, Yu ansa dem from heaven. Bikos of yor great mesi, Yu send leaders wey kom save dem from dia enemies.
NEH 9:28 Wen dem get peace, dem kon sin again and Yu allow dia enemies attack dem. But wen dem turn kom meet Yu for help, Yu hear dem from heaven and Yu save dem many-many times, bikos of yor mesi.
NEH 9:29 Yu warn dem sey make dem obey wetin Yu tish, but dem rijet yor law bikos of pride and even doh yor law dey give life, dem nor gri obey am, bikos of dia strong head and sturbones.
NEH 9:30 Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.
NEH 9:31 But bikos of yor great mesi, Yu nor distroy dem finish or abandon dem forever. Si as Yu dey good and dey show mesi!
NEH 9:32 Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.
NEH 9:33 Yu still dey rite even wen Yu ponish us. Wi really don sin well-well and Yu give us di ponishment wey fit us.
NEH 9:34 Awa grand-grand papa dem, awa kings, leaders and priests nor keep yor law at-all. Dem nor listin to yor kommands and laws.
NEH 9:35 Even wen dem get dia kingdom, dem nor gri serve Yu, doh Yu still show dem yor goodness. Yu give dem betta land to plant, yet dem nor gri turn from dia wikedness.
NEH 9:36 So today, wi bi slave for di land wey Yu give us. Di betta land where Yu give awa papa dem to chop from and enjoy as e good rish.
NEH 9:37 Di king wey Yu put ova us, bikos wi sin, na-im get evritin wey di land dey produce. Na wetin dem like dem dey do with wi and awa animals and wi really dey sofa for dia hand.
NEH 9:38 “Bikos of all wetin don happen, wi promise and rite agriment kon allow awa leaders, Levi pipol and di priests stamp am.”
NEH 10:1 Di pipol wey sign na: Nehemaya wey bi govnor, Hakalaya pikin, and Zedekaya sign too. Di oda pipol wey still sign na:
NEH 10:2 Di priests: Seraya, Zabud, Jeremaya,
NEH 10:3 Pashhur, Amaraya, Malkijah,
NEH 10:4 Hattush, Shebanaya, Malluk,
NEH 10:5 Harim, Meremot, Obadaya,
NEH 10:6 Daniel, Ginneton, Baruk,
NEH 10:7 Meshullam, Abijah, Mijamin,
NEH 10:8 Maazaih, Bilgai and Shemaya.
NEH 10:9 Levi pipol wey sign na: Jeshua wey Azanaya born, Binnui from Henadad family, Kadmiel,
NEH 10:10 Shebanaya, Hodaya, Kelita, Pelaaya, Hanan,
NEH 10:11 Mikah, Rehob, Hashabaya,
NEH 10:12 Zakkur, Sherebaya, Shebanaya,
NEH 10:13 Hodaya, Bani and Beninu.
NEH 10:14 Di leaders wey sign na: Parosh, Pahat-Moab, Elam, Zattu, Bani,
NEH 10:15 Bunni, Azgad, Bebai,
NEH 10:16 Adonijah, Bigvai, Adin,
NEH 10:17 Ater, Hezekaya, Azzur,
NEH 10:18 Hodaya, Hashum, Bezai,
NEH 10:19 Harif, Anatot, Nebaya,
NEH 10:20 Magpiash, Meshullam, Hezir,
NEH 10:21 Meshezabel, Zadok, Jaddua,
NEH 10:22 Pelataya, Hanan, Anaya,
NEH 10:23 Hoshea, Hananaya, Hasshub,
NEH 10:24 Hallohesh, Pilha, Shobek,
NEH 10:25 Rehum, Hashabnah, Maaseaya,
NEH 10:26 Ahijah, Hanan, Anan,
NEH 10:27 Malluk, Harim and Baanah.
NEH 10:28 Naw di remainin Israel pipol, di priests, Levi pipol, doz wey dey guide, sing and work for di temple and evribody wey obey God law kon separate demsef from doz strenjas wey dey stay for di town. Both wi, awa wifes and shidren wey don get sense to undastand,
NEH 10:29 join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.
NEH 10:30 Wi promise sey awa dota nor go marry di strenjas wey dey stay for awa land.
NEH 10:31 Wi still promise sey wi nor go buy korn or anytin wey strenjas go karry kon sell for us for Sabat Day or for any oda day wey holy. For evry sevent year, wi nor go plant anytin for di land and wi go kounsol all di debt wey pipol dey owe us.
NEH 10:32 Evry year, wen wi divide awa silva into eight, wi go drop one part for di temple work.
NEH 10:33 Anytime dem dey woship for di temple, wi go provide dis tins: di holy bread, di korn wey dem dey give evriday as ofrin, di animals wey dem go burn as sakrifice for each day, di holy ofrins for Sabat Day, di new moon festivals and oda festivals, di oda holy ofrins, di ofrin wey go remove Israel sins and anytin wey dem nid for di temple.
NEH 10:34 Wi, di pipol, di priests and Levi pipol, go trow dice evry year to know di family wey go dey burn di sakrifice wey dem offa give di Oga awa God, akordin to wetin dey di law.
NEH 10:35 Evry year, wi go take di first korn wey wi harvest go di temple as ofrin and even di first fruit wey go ripe for awa trees, wi go give dem too.
NEH 10:36 Wi go karry di first boy pikin wey awa wife born go meet di priest for di temple and dem go dedikate am give God, just as dem rite am for di law. Wi go still dedikate di first melu, sheep, lamb and goat wey awa animals go born.
NEH 10:37 Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am.
NEH 10:38 One priest wey kom from Aaron shidren-shidren must dey with Levi pipol wen dem dey kollect tithe and Levi pipol go bring one from evry ten tins wey dem kollect kom keep am for di store for awa Oga God Temple.
NEH 10:39 Israel and Levi pipol must take di korn, wine and olive oil wey dem kontribute go keep for di temple where dem dey keep tins put and where di priest wey dey duty, doz wey dey guide and sing for di temple dey stay. Wi nor go forget awa Oga God house.
NEH 11:1 Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.
NEH 11:2 Di pipol tank di ones wey sey dem go stay for Jerusalem.
NEH 11:3 Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah,
NEH 11:4 but some among di pipol for Judah and Benjamin go back to Jerusalem, na dem bi.) From Judah tribe: Uzzaya wey Zekaraya pikin Ataya born and na Amaraya born Zekaraya. Na Shefataya wey Perez pikin Mahalalel born, bi Amaraya papa.
NEH 11:5 Wi still get Maaseaya wey bi Baruk pikin and na Kol-Hozeh wey Hazaya born, bi Baruk papa. Hazaya na Adaya pikin wey Joiarib born and na Zekaraya wey Shelah born, bi Joiarib papa.
NEH 11:6 Perez shidren-shidren wey dey for Jerusalem na 468 and all of dem na betta men.
NEH 11:7 From Benjamin tribe: Wi get Sallu wey Meshullam born, wey Joed born, wey Pedaaya born, wey Kolaya born, wey Maaseaya born, wey Itiel born, wey Jeshaya born.
NEH 11:8 Pipol wey follow am na Gabbai and Sallai and dia family na 928.
NEH 11:9 Na Joel wey Zikri born bi dia oga and na Hassenuah pikin, Judah bi next afta am for di town.
NEH 11:10 From di priest: Wi get Jedaya wey bi Joiarib pikin and Jakin
NEH 11:11 and Seraya wey Meshullam pikin, Hilkaya born. En grand-papa dem na Zadok, Meraiot and Ahitub wey dey guide God Temple.
NEH 11:12 Wi still get 822 pipol wey dey work with am for di temple. Wi get Adaya wey Jeroham born, wey Pelalaya born, wey Amzi born, wey Zekaraya born, wey Pashhur born, wey Malkijah born
NEH 11:13 with 242 pipol wey bi head for dia family. Wi still get Amashsai wey Azarel born, wey Ahzai born, wey Meshillemot born, wey Imma born
NEH 11:14 and 128 of en strong men follow am. Di pesin wey dey lead dem na Zabdiel wey Haggedolim born.
NEH 11:15 From Levi tribe: Wi get Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born, wey Bunni born.
NEH 11:16 Wi still get Shabbetai wey Jozabad born, wey bi oga for di work wey dem dey do outside God Temple.
NEH 11:17 Wi still get Matanaya wey Mikah born, wey Zabdi, Asaf pikin born and na-im dey lead di tanksgivin and prayer. E still get Bakbukaya wey dey support Matanaya and Abda wey Shammua born, wey Galal born, wey Jedutun born.
NEH 11:18 All di Levi pipol for di holy town na 284.
NEH 11:19 Among doz wey dey guide di gate: E get Akkub, Talmon and 172 pipol.
NEH 11:20 God priests, Levi pipol and di rest pipol for Israel dey stay where dia family land dey for Judah.
NEH 11:21 But doz wey dey serve for di temple dey stay for Ofel Hill and dia leaders na Ziha and Gishpa.
NEH 11:22 Di main Levi pipol oga for Jerusalem na Uzzi wey Bani born, wey Hashabaya born, wey Matanaya born, wey Mikah wey bi Asaf grand-pikin born and na en family dey sing for God Temple.
NEH 11:23 Dem dey do evritin as e suppose bi evriday, just as dem rite am for di royal kommand wey dem dey follow.
NEH 11:24 Petahaya wey Meshezabel born wey dey among Zera shidren-shidren from Judah tribe, na-im dey advise di king for all di matter wey koncern how to rule and kontrol di pipol.
NEH 11:25 But for di village around dia fields, some among di pipol for Judah dey stay Kiriat-Arba, Dibon and Jekabzeel with di place and village wey dey der.
NEH 11:26 Dem still dey stay for Jeshua, Moladah, Bet-Pelet,
NEH 11:27 Hazar-Shual, Beersheba and di village for
NEH 11:28 Ziklag, Mekona and dia village.
NEH 11:29 Dem still dey stay En-Rimmon, Zorah, Jarmut,
NEH 11:30 Zanoah and Adullam with di village wey dey der. Dem still dey Lakish with di field wey dey near der and Azeka with en village. So Judah pipol stay from Beersheba go di sout valley for Ben-Hinnom.
NEH 11:31 Some pipol from Benjamin tribe dey stay for Gibeah, Mikmash, Aija and Bethel with di arias for der.
NEH 11:32 Dem still dey stay for Anatot, Nob, Ananaya,
NEH 11:33 Hazor, Rama, Gittaim,
NEH 11:34 Hadid, Zeboim, Neballat,
NEH 11:35 Lod, Ono and Wise Men Valley.
NEH 11:36 So, dem send some among Levi pipol wey dey Judah go join Benjamin pipol.
NEH 12:1 Di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon with Shealtiel pikin Zerubabel and Jeshua wey bi di High Priest na: Seraya, Jeremaya, Ezra,
NEH 12:2 Amaraya, Malluk, Hattush,
NEH 12:3 Shekanaya, Rehum, Meremot,
NEH 12:4 Iddo, Ginnetoi, Abijah,
NEH 12:5 Mijamin, Moadaya, Bilgah,
NEH 12:6 Shemaya, Joiarib, Jedaya,
NEH 12:7 Sallu, Amok, Hilkaya and Jedaya. Dis na di leaders among di priest and doz wey dey work with dem wen Jeshua bi di High Priest.
NEH 12:8 Levi pipol wey kom back with dem na: Jeshua, Binnui, Kadmiel, Sherebaya, Judah and Matanaya and na dem with dia pipol dey sing dey tank God.
NEH 12:9 Di pipol wey follow dem na Bakbukaya and Unni and dem dey stand opposite dem wen di service dey go on.
NEH 12:10 Jeshua wey bi di High Priest na Joiakim papa. Joiakim na Eliashib papa and Eliashib na Joiada papa.
NEH 12:11 Joiada na Jonatan papa and Jonatan na Jaddua papa.
NEH 12:12 So wen Joiakim na High Priest, doz wey dey lead for di priest family na: Meraaya wey dey lead Seraya family; Hananaya wey dey lead Jeremaya family;
NEH 12:13 Meshullam wey dey lead Ezra family; Jehohanan wey dey lead Amaraya family;
NEH 12:14 Jonatan wey dey lead Malluk family; Josef wey dey lead Shebanaya family;
NEH 12:15 Adna wey dey lead Harim family; Helkai wey dey lead Meraiot family;
NEH 12:16 Zekaraya wey dey lead Iddo family; Meshullam wey dey lead Ginneton family and
NEH 12:17 Zikri wey dey lead Abijah family. Dem still get one leader for Mijamin family. Piltai dey lead Moadaya family;
NEH 12:18 Shammua dey lead Bilgah family; Jonatan dey lead Shemaya family;
NEH 12:19 Mattenaya dey lead Joiarib family; Uzzi dey lead Jedaya family;
NEH 12:20 Kallai dey lead Sallu family; Eber dey lead Amok family;
NEH 12:21 Hashabaya dey lead Hilkaya family and Netanel wey dey lead Jedaya family.
NEH 12:22 Dem keep one book about Levi family for di time wen Eliashib, Joiada, Johanan and Jaddua dey serve as High Priest. Anoda rekord for di priest dey for di time wen Darius dey rule Persia.
NEH 12:23 Di head for Levi family rite dia names put for di history book until di time wey Eliashib grand-pikin, Johanan dey rule.
NEH 12:24 Dis na di family leaders for Levi tribe: Hashabaya, Sherebaya, Jeshua, Binnui, Kadmiel and di oda men wey dey stand face dem wen dem dey do di praiz and tanksgivin service and just as David wey dey serve God kommand dem, one group dey praiz with di oda group.
NEH 12:25 Dem bi Matanaya, Bakbukaya and Obadaya. Na Meshullam, Talmon and Akkub dey guide di gate and di store room for di gates.
NEH 12:26 All dis men serve for di time wen King Joiakim wey Jehozadak pikin Jeshua born, dey rule and dat time Nehemaya na govnor, while Ezra na priest.
NEH 12:27 Wen dem won dedikate di new wall for Jerusalem, dem sey make Levi pipol from evriwhere for di land kom Jerusalem kon support dem for di party. Dem sey make dem join for dis serimony as dem dey sing and tank God with dia cymbals, harp and lyres.
NEH 12:28 Dem bring doz wey dey sing from evriwhere for Jerusalem and from di village dem wey dey Netofat.
NEH 12:29 Dem still kom from Bet-Gilgal and di poor arias near Gibeah and Azmavet, bikos doz wey dey sing don build dia own house round Jerusalem.
NEH 12:30 Di priest and Levi pipol first santify demsef; den dem kon santify di pipol, di gates and di wall.
NEH 12:31 I take di leaders for Judah go on-top di wall kon organize two big kwaya wey go give tanks. One among di kwaya face sout for di Dirty Gate.
NEH 12:32 Hoshaaya and half for di leaders for Judah follow dem,
NEH 12:33 with Zabud, Ezra, Meshullam,
NEH 12:34 Judah, Benjamin, Shemaya and Jeremaya.
NEH 12:35 Den some priest wey dey blow trumpet kon kom with Zekaraya wey Jonatan born, wey Shemaya born, wey Matanaya born, wey Mikaya born, wey Zakkur wey kom from Asaf shidren-shidren, born.
NEH 12:36 Zekaraya friends na Shemaya, Azarel, Milalaya, Gilalai, Maai, Netanel, Judah and Hanani and dem dey use di music instrument wey God savant, David give dem. Na Ezra bi di kwayamasta.
NEH 12:37 For di Well Gate, dem klimb go di town wall wey face David Town. Dem pass David house kon dey waka go di Wota Gate for east.
NEH 12:38 Di sekond kwaya wey dey tank God kon go di nort side thru di oda side make dem for meet di oda pipol. I follow dem with di oda half of di leaders, on-top di wall until wi pass Ovens Towa go rish di Broad Wall,
NEH 12:39 den wi pass Efraim Gate till wi rish di Hundred Towa. Wi waka go rish di Sheep Gate kon stop for di Guide Gate.
NEH 12:40 Di two kwaya wey dey give tanks kon go awa Oga God Temple, den dem take dia pozishon. So mi and all di group leaders kon sidan.
NEH 12:41 Wi follow di priests wey dey blow di trumpet and dem bi: Eliakim, Maaseaya, Mijamin, Mikaya, Elioenai, Zekaraya and Hananaya
NEH 12:42 and doz wey dey sing na: Maaseaya, Shemaya, Eleazar, Uzzi, Jehohanan, Malkijah, Elam and Ezer. Dem play kon dey sing well-well and na Jezrahaya bi di kwayamasta.
NEH 12:43 For dat day wen pipol dey happy, dem offa many sakrifice, bikos God don give di pipol rizin to dey happy. Di wimen and shidren still join for di celebrashon and evribody from far know sey betta tin dey happen for Jerusalem.
NEH 12:44 Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.
NEH 12:45 Dem dey do dia God work kon santify pipol, just as David and Solomon en pikin kommand and doz wey dey sing and guide di gate, dey do di same tin too.
NEH 12:46 Di tradishon to get kwayamasta wey go lead di pipol for praiz, hymns and tanksgivin don start since David and Asaf time.
NEH 12:47 So naw, for Zerubabel and Nehemaya days, evribody for Israel dey bring food evriday for doz wey dey sing, guide di gate and for Levi pipol. Levi pipol dey still give part of wetin dem kollect to di priests wey bi Aaron shidren-shidren.
NEH 13:1 Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.
NEH 13:2 And dis na bikos Ammon and Moab pipol nor gri give Israel pipol food or wota drink wen dem dey komot from Egypt. Instead, dem give Balaam money make e curse Israel, but awa God turn di curse to blessing.
NEH 13:3 Wen Israel pipol hear dat part for di law, dem nor kon add all di strenjas for di town join.
NEH 13:4 Before dis time, Priest Eliashib wey bi Tobaya broda, dey kare for di temple store room.
NEH 13:5 E build one big room where dem bin dey keep korn ofrins and incense, di tins wey dem dey use for di temple, di ofrin wey bi priests own and one from evry ten tins wey pipol bring from dia korn, wine and olive oil wey dem give Levi pipol and doz wey dey guide and sing for di temple.
NEH 13:6 I nor dey Jerusalem wen dis tins dey happen, so for di thirty-two years wen Atazazes bi king for Babilon, I kon go ripot gi-am. Afta sometaim, e permit mi
NEH 13:7 and I kon go back to Jerusalem. I shok wen I si sey Eliashib allow Tobaya dey use one room for di temple.
NEH 13:8 I vex well-well kon trowey Tobaya tins for outside.
NEH 13:9 I kon orda sey make dem do sakrifice take santify di room and make dem put di temple tins, korn ofrins and incense back for der.
NEH 13:10 I still hear sey, doz wey dey sing for di temple and some among Levi pipol don leave Jerusalem kon go back to dia farms, bikos di pipol nor dey give dem food.
NEH 13:11 So I kworel with di leaders kon ask dem, “Wetin make una forget God Temple?” Den I go bring Levi pipol and doz wey dey sing kom back to di temple, so dat dem go start dia work again.
NEH 13:12 Den Israel pipol kon start to dey bring one out of evry ten korn, wine and olive oil kom di temple store room again.
NEH 13:13 So I kon put dis men make dem dey guide di store room and dem bi, Shelemaya wey bi priest; Zadok wey know di law well-well and Pedaaya wey kom from Levi family. Hanan wey Matanaya pikin Zakkur born, na-im dey help dem. I know sey I go fit trust dis men wen dem dey share di tins give di pipol wey dey follow dem work.
NEH 13:14 My God, make Yu remember all dis tins wey I don do for yor temple and for yor work.
NEH 13:15 For dat time, I si pipol for Judah dey make juice from grapes for Sabat Day. While some dey load korn, wine, grapes, figs and oda tins on-top dia donkey kon take dem go Jerusalem. So I warn dem sey make dem nor sell anytin for Sabat Day.
NEH 13:16 Some men wey kom from Tyre town dey stay for Jerusalem and dem bring difren tins kom di town kon sell for awa pipol for Sabat Day.
NEH 13:17 I kworel with di Jew leaders kon tell dem, “Si di kind bad tin wey una dey do! Una nor wont make di Sabat Day dey holy.
NEH 13:18 Na dis tin make God ponish una grand-grand papa dem kon distroy di town. Yet una still dey won make God vex well-well for Israel, bikos una nor dey make di Sabat Day holy.”
NEH 13:19 So I kon give orda sey make dem dey lock di town gate for morning go rish evening for evry Sabat Day and make dem nor open am until dat day finish. I put some among my men for di gate, make dem make sure sey dem nor karry anytin enter or go outside di town for Sabat Day.
NEH 13:20 One or two time, pipol wey dey sell difren tins dey sleep outside di town.
NEH 13:21 So I warn dem, “No nid to dey wait for outside till morning. If una try am again, I go ponish una.” From dat time go, dem nor kon dey kom der for Sabat Day.
NEH 13:22 I give orda sey make Levi pipol go santify demsef, den kon guide di gate to make sure sey dem keep di Sabat Day holy. My Oga God, make Yu still remember mi kon save mi, bikos of yor great love.
NEH 13:23 For dat time, I notis sey many among Jew men marry wimen from Ashdod, Ammon and Moab town.
NEH 13:24 Half of dia shidren dey speak Ashdod language (or some oda language), but dem nor fit speak Hibru language.
NEH 13:25 I kworel, curse, slap and pul di men hair. Den I make dem swear with God name sey dem and dia shidren nor go ever marry from anoda kountry.
NEH 13:26 I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.
NEH 13:27 So e good make wi dey hear all dis una wiked tins and how una disobey awa God and marry wimen from oda kountries?”
NEH 13:28 Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.
NEH 13:29 My God, make Yu remember dem, bikos dem don spoil di priests work and break di priest and Levi pipol kovenant.
NEH 13:30 So I santify di pipol from evry strenj tin kon tell di priests and Levi pipol wetin dem go do.
NEH 13:31 I still provide di wood wey dem go use take burn di ofrin for di rite time and for di first korn and fruit. My God, I beg, make Yu remember mi for good and bless mi.
EST 1:1 Dis tin happen for di time wey King Zazes dey rule. (I dey tok about di Zazes wey rule more dan 127 kountries, from India go rish Ethiopia).
EST 1:2 For dat time, King Zazes dey rule en kingdoms from en throne for Shushan
EST 1:3 and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.
EST 1:4 E show dem di propaty wey e get and how en kingdom go big rish forever and na one hundred and eight days e take do di party!
EST 1:5 Wen doz days don komplete, di king do party for all di men wey dey Shushan, both di senior and di junior workers. Dem use seven days take do di party for di royal palis gardin.
EST 1:6 Na white and blue curtain wey dem tie with fine purpol linen with silva ring and betta stones, dem take dekorate di kourtyard. Dem put tins wey dem make with gold and silva, for di kourtyard groun wey dem design with white, red, blue and black stones.
EST 1:7 Na gold cup dem take serve drinks and all di cup get difren design. Di king give dem enough royal wine.
EST 1:8 Di drinks many well-well; di king don orda en savant sey make evribody chop and drink until dem taya or beleful.
EST 1:9 Inside di royal palis, Kween Vashti sef dey do party for di wimen.
EST 1:10 For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,
EST 1:11 sey make dem go bring Kween Vashti and make e wear en royal crown. Di kween fine well-well and di king won use am take make yanga for en ofisas and doz wey e invite.
EST 1:12 But wen di savant tell di kween wetin di king kommand, e nor gri kom. Dis tin kon make di king vex well-well.
EST 1:13 So di king kon ask di wise men wey know about matter wey koncern dia law and rule, bikos e dey always ask dem for advise.
EST 1:14 Di pipol wey e dey always koll for advise na: Karshena, Shetar, Admata, Tarshish, Meres, Marsena and Memukan and dem bi seven ofisas for Persia and Media wey get di highest pozishon for di kingdom.
EST 1:15 E tell di men, “Mi, King Zazes send my savant go koll Kween Vashti, but di kween nor gri kom! Wetin di law sey make wi do to am?”
EST 1:16 Den Memukan tell di king and en ofisas: “Kween Vashti nor only curse di king, but e don curse en ofisas, In-short, e don curse di whole kingdom!
EST 1:17 Evry woman for di kingdom nor go kon dey respet dia husband again wons dem hear sey, ‘King Zazes koll Kween Vashti make e kom meet am, but di kween nor gri go.’
EST 1:18 And before today go end, di ofisas for Persia and Media wifes go hear dis tin wey Kween Vashti do so and dem nor go ever respet and fear dia husband again.
EST 1:19 “So if my king go like am, make yu kommand sey make Vashti nor ever kom near di king again. Make yu let us rite am put for Persia and Media law, so dat dem nor go ever fit shange am. Den yu go give en place as kween to anoda betta woman.
EST 1:20 Wen di whole kingdom don know wetin yu do, evry woman go trit en husband with respet, weda e get money or e nor get.”
EST 1:21 Di King and en ofisas like wetin Memukan tok kon do am.
EST 1:22 E send message go all di kingdoms for Persia and Media sey evry husband must bi di head for en house and na wetin e tok, dem must obey.
EST 2:1 Leta wen di king nor dey vex again, e kon dey tink about wetin Vashti do and wetin e kommand about am.
EST 2:2 So some among di king advise wey dey klose to am kon sey, “E go good make wi go find one fine girl wey bi virgin for yu?
EST 2:3 Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.
EST 2:4 Den yu go take di girl wey yu like pass kon make am kween to replace Vashti.”
EST 2:5 E get one Jew wey dey stay for Shushan and en name na Mordekai wey bi Jair pikin; e kom from Kish and Shimei family for Benjamin tribe.
EST 2:6 Wen King Nebukadnezzar for Babilon karry King Jehoiakim for Judah from Jerusalem go prison with oda pipol, Mordekai family dey join dem.
EST 2:7 Mordekai get one fine kousin wey en name na Estha and en Hibru name na Hadassa. Wen di girl papa and mama die, Mordekai take and train am as en own pikin.
EST 2:8 Wen di king kommand make dem bring girls kom Shushan, Estha dey join dem too. Estha sef dey di royal palis and na Hegai dey kare for all di king wimen.
EST 2:9 Hegai like Estha bikos of wetin e dey do and how e dey do tins. E know waste time before e sey make dem dey trit Estha well both for wetin e wont and food wey e go chop. E give Estha di best place to stay kon choose seven girls from di royal palis wey go dey attend to am.
EST 2:10 Naw, just as Mordekai tok, Estha nor tell anybody sey e bi Jew.
EST 2:11 Evriday, Mordekai dey go meet Estha, so dat e go know how tins bi with am.
EST 2:12 Dem trit di girls well for one year, dem massage dem with myrrh oil for six monts and balsam oil for di oda six monts. Afta, dem kon dey take each girl go meet di king.
EST 2:13 Wen e rish time for any of di girls to go meet di king, any klot or tin wey di girl ask for, dem dey gi-am.
EST 2:14 E go-go der for evening kon kom back for morning, den dem go take am go meet Shaashgaz wey dey kare for di king girl-friends. Di girl nor go-go meet di king again, unless di king like am kon ask of en name.
EST 2:15 Time kon rish for Estha to go meet di king. Estha na Abihail pikin and Mordekai kousin and anybody wey si am, dey like am. Wen e turn rish, e wear wetin Hegai wey dey kare for dem sey make e wear.
EST 2:16 So for di sevent year wen King Zazes dey rule, for di tent mont wey bi Tebet mont, dem bring Estha kom meet King Zazes for di royal palis.
EST 2:17 Di king like am pass any of di oda girls and Estha kon win di king heart. E put di royal crown for Estha head kon make am kween take replace Vashti.
EST 2:18 Den di king do big party kon invite all en ofisas to take honor Estha. E give holy day to evribody for en kingdom kon give dem betta-betta gifts.
EST 2:19 For di time wen dem dey karry di oda wimen go where dem go stay, na Mordekai dey guide di palis gate.
EST 2:20 Estha still nor let di king know sey en bi Jew. Mordekai don tell am sey make e nor tell anybody and e obey am, just as e dey always obey am.
EST 2:21 One day wen Mordekai dey work for di palis gate, Bigtan and Teres wey bi ofisas wey dey guide di king door-mot kon dey vex and plan to kill King Zazes.
EST 2:22 Wen Mordekai know dia plan, e kon go tell Kween Estha, den di kween tell di king wetin Mordekai tok.
EST 2:23 Dem kon shek well and dem fine out sey wetin Mordekai tok, na true, so dem kon hang di two men. Dem rite all wetin happen so for di king rekord book.
EST 3:1 Afta, King Zazes kon promote Haman wey bi Hammedata pikin from Agag town. E make en pozishon high pass evry oda pozishon for di kingdom.
EST 3:2 Bikos of dis, all di king savants wey dey for di king gate kon dey bow and respet Haman, bikos di king don kommand sey make e bi like dat. But, Mordekai nor gri bow or gi-am respet.
EST 3:3 So di king savants wey dey di palis gate kon ask Mordekai, “Wetin make yu dey go against di king kommand?”
EST 3:4 And wen dem tok to Mordekai well-well and e nor ansa dem, dem kon tell Haman wetin Mordekai dey do, so dat dem go hear wetin Heman go tok, bikos Mordekai don tell dem sey en na Jew.
EST 3:5 Wen Haman si sey Mordekai nor gri bow or gi-am respet, e vex well-well
EST 3:6 and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.
EST 3:7 For di twelft year wen King Zazes dey rule, for di first mont wey bi Nisan, Haman kon sey make dem trow dice (na Purim dem dey koll am), so dat e go know di rite day and mont to do wetin e plan. E kon agri to do en plan for di thirtint day for di twelft mont, wey bi Adar.
EST 3:8 So Haman tell di king, “E get one tribe wey dem full evriwhere for dis yor kingdom wey get difren law. Dem nor dey follow di king law. So e nor dey good for di king to allow dem live.
EST 3:9 So my oga, if yu wont, make yu kommand make dem kill all dis pipol. If yu do like dat, den I go get like 10,000 big sak for silva for di royal pus for di kingdom.”
EST 3:10 Di king kon remove en ring wey dem take dey stamp law, so dat e go get pawa kon gi-am to Haman wey bi Hammedata pikin from Agag and dis Haman na Jew enemy.
EST 3:11 Di king tell am, “Make yu nor worry about di money, just go do wetin yu like with di pipol.”
EST 3:12 So for di thirtint day for di first mont, Haman koll di king seketry kon sey make e rite dis kommand for all di language for di kingdom kon send am go meet all di rulers, govnors and ofisas for di kingdom. Dem rite am with King Zazes name kon stamp am with en ring.
EST 3:13 Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.
EST 3:14 Dem must read dis kommand to evribody for di kingdom, so dat dem go dey ready wen dat day go rish.
EST 3:15 Just as di king kommand, dem kon tok evritin for di main town for Shushan and di messenjas karry am go evriwhere for di kingdom. Di king and Haman dey drink and enjoy diasef, while evribody for Shushan town, dey run up-and-down.
EST 4:1 Wen Mordekai hear evritin wey dey happen, e tear en klot kon wear sak, pak ashes for en head; den e go di town centre kon dey kry.
EST 4:2 But e nor waka pass di king gate: bikos nobody wey wear sak klot go fit pass der.
EST 4:3 And for evry aria where dem for read dis law, Jew pipol wey dey der, dey kry, fast, wear sak klot kon pak ashes for dia head.
EST 4:4 Wen Estha savants tell am wetin dey happen, e vex well-well kon sey make dem go remove Mordekai sak klot kon wear am betta klot, but Mordekai nor gri.
EST 4:5 Den Estha koll Hatak, one offisa for di palis wey di king sey make e dey serve am kon send am go ask Mordekai, make e tell am wetin dey happen.
EST 4:6 Hatak go meet Mordekai for di town centre for di palis gate.
EST 4:7 Mordekai tell am evritin wey dey happen and all di money wey Haman sey di kingdom go get, wen dem don kill all Jew pipol.
EST 4:8 E give Hatak one kopy for di kommand wey dem read for Shushan, sey make dem kill all Jew pipol. Mordekai sey make e go give and tell Estha evritin, so dat e go beg di king make e sorry for en pipol.
EST 4:9 Hatak do as Mordekai tell am,
EST 4:10 den Estha sey make e go give Mordekai dis message:
EST 4:11 “If anybody, weda na man or woman enter di inna kourtyard go si di king without sey e koll am, dat pesin must die. Dat na di law; evribody from doz wey dey advise di king go rish evriwhere for di kingdom, know sey na so e bi. But na only one way wi fit take break dis law: if di king show pesin en gold rod, den dem nor go kill dat pesin. But e don rish one mont since di king sey make dem koll mi kom.”
EST 4:12 Wen Mordekai hear Estha message,
EST 4:13 e kon sey make dem go warn am, “Make yu nor feel sey yu dey save pass any oda Jew pesin, bikos yu dey stay for palis.
EST 4:14 If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”
EST 4:15 So Estha ansa Mordekai:
EST 4:16 “Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
EST 4:17 So Mordekai kon go do evritin wey Estha tell am.
EST 5:1 For di third day, Estha wear en royal dress kon go stand for di inna kourtyard gate for di palis wey face di throne room and di king sidan for di throne.
EST 5:2 Wen di king si Estha for di gate, belle sweet am, den e stresh en gold rod and Estha kon go tosh di rod.
EST 5:3 Di king ask am, “My kween, wetin dey happen? Make yu tell mi anytin wey yu wont (even if na half of my kingdom), I go gi-am to yu.”
EST 5:4 Estha ansa, “Abeg my king, I go like make yu and Haman kom di party wey I dey organize for yu.”
EST 5:5 So di king sey make dem koll Haman kom kwik-kwik, so dat dem go-go Estha party. Leta dat day, dem kon go di party.
EST 5:6 As dem dey drink, di king kon ask Estha, “Make yu tell mi wetin yu wont and I go do am for yu; even if na half of my kingdom yu ask for.”
EST 5:7 Estha ansa, “Dis na wetin I dey ask and pray for:
EST 5:8 If my oga really wont do wetin I go ask for, I go wont make yu and Haman kom di party wey I go do for una tumoro, den I go tell yu wetin I wont.”
EST 5:9 Wen Haman dey go en house afta di party, e kon dey happy and belle sweet am. But e kon si Mordekai for di palis gate and wen Mordekai nor greet am as e dey pass, Haman kon dey vex well-well.
EST 5:10 But e kontrol ensef kon go house. Den e invite en friends kom en house kon sey make en wife, Zeresh join dem.
EST 5:11 E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.
EST 5:12 Haman still sey, “Na wetin remain? Even di kween do party for di king and na only mi e invite to follow am and e still sey make wi kom back tumoro.
EST 5:13 But all dis tin nor mean anytin as long as I dey si dat Jew wey koll ensef Mordekai for di palis gate.”
EST 5:14 So Zeresh en wife and en friends kon sey, “Go make one pole where dem dey hang pesin put and make e high rish seventy-five fit. Tumoro morning, make yu tell di king sey make dem hang Mordekai for der, den belle go sweet yu go di party.” Haman like wetin dem tok, so e kon make di pole.
EST 6:1 Thru-out dat nite, di king know fit sleep, so e sey make dem bring di ofisas rekord book for di kingdom kom, den dem kon bring and read am for am.
EST 6:2 Di part wey dem read, na about how Mordekai take tok about Bigtan and Teres (di king ofisas before) wey bin dey plan to kill King Zazes.
EST 6:3 Di king kon ask, “Wi don honor and reward Mordekai for dis tin wey e do?” Di king savant ansa, “No! Wi neva do anytin for am.”
EST 6:4 Den di king ask, “Any of my ofisas dey di palis?” Naw, Haman just dey enter di palis make e kom tell di king, sey make dem hang Mordekai.
EST 6:5 Di king savants tell di king, “Haman just dey enter.” So di king sey, “Make una koll am kom.”
EST 6:6 So Haman enter inside and di king kon tell am, “Wetin wi fit do for di man wey di king like to honor?” Haman kon tink for en mind sey, “Wish pesin di king go wont honor, escept mi?”
EST 6:7 So Haman tell di king, “Make yu tell di savant make
EST 6:8 dem bring di king royal garment and di royal horse wey di king don ride before, kom.
EST 6:9 Den make one of di king men dress di pesin kon dey lead am thru di town as e dey on-top di horse. Make di king offisa dey shaut as dem dey go sey: ‘Make una si how di king dey reward di pesin wey e choose to honor!’ ”
EST 6:10 Den di king tell Haman, “Make yu go kwik-kwik! Kollect di garment and horse, den do all dis tins wey yu tok for Mordekai, di Jew wey dey di palis gate.”
EST 6:11 So Haman take di klot and di horse kon wear dem for Mordekai. Den e kon lead am thru di town dey shaut, “Make una si how di king dey reward di man wey e choose to honor.”
EST 6:12 Den Mordekai go back to di palis gate, while Haman kover en face with shame kon run go house.
EST 6:13 Haman kon tell en wife Zeresh and all en friends evritin wey happen to am. En friends with en wife Zeresh kon tell am, “Yu don dey luz pawa to dis Mordekai. E bi Jew pesin and yu nor go fit win am. True-true e go win yu.”
EST 6:14 As dem still dey tok, di palis offisa kon hurry kom, so dat e go karry Haman go Estha party.
EST 7:1 So di king and Haman kon go chop with Kween Estha
EST 7:2 for di sekond time. As dem dey drink wine, di king kon ask Estha, “My kween, na wetin yu wont make I do for yu? Make yu tell mi and I go do am for yu. I go even give yu half of my kingdom.”
EST 7:3 Estha ansa, “Abeg! My king, if yu go agri with wetin I wont, den make yu nor allow dem kill mi and my pipol.”
EST 7:4 Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.
EST 7:5 Den King Zazes ask Kween Estha, “Na who won kill una? Where di pesin dey?”
EST 7:6 Estha ansa, “Na dis Haman bi di pesin wey won kill all of us!” Den Haman kon dey fear as e dey look di king and kween.
EST 7:7 Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.
EST 7:8 As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin. As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?” As di king still dey tok, dem kon kover Haman face.
EST 7:9 Den one of di king savant wey dem dey koll Harbona kon sey, “Na true, Haman even dig one pit for en house where e won hang Mordekai put and na dis Mordekai save my king life. Di pit deep rish seventy-five fit!” Di king kon sey, “Make una go hang Haman put for di pit wey e dig!”
EST 7:10 So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
EST 8:1 For dat same day, King Zazes give Kween Estha all di propaty wey Haman, Jew pipol enemy, get. Estha tell di king sey Mordekai rilate to am and from dat day go, Mordekai kon dey enter di palis as e like.
EST 8:2 Den di king remove en ring (di one wey e take back from Haman) kon gi-am to Mordekai. And Estha sey make Mordekai kare for Haman propaty.
EST 8:3 Leta, Estha kon knee down dey kry as e dey beg di king make e do sometin about di wiked tin wey Haman, wey kom from Agag, plan for Jew pipol.
EST 8:4 Di king stresh en gold rod for Estha, so e get up kon sey,
EST 8:5 “If di king like and kare about mi and if e dey good for yor eye, make yu kommand yor ofisas make dem nor do di tins wey Haman, Hammedata pikin, from Agag, rite about all di Jew pipol for di kingdom.
EST 8:6 Bikos how I wont take stay, if dis tin happen and dem kon kill all my pipol?”
EST 8:7 So King Zazes tell Estha and Mordekai sey, “Make una si, I don already give Haman propaty to Estha and dem don hang am, bikos of en wiked plan against Jew pipol.
EST 8:8 But di pipol must do wetin dem kommand and stamp with di king name. Yu fit rite anytin wey yu like go give Jew pipol kon stamp am with di royal stamp with my name.”
EST 8:9 Dis tin happen for di twenteth day for di third mont wey bi Sivan. Mordekai koll di king seketry and dem take all di leta wey Mordekai rite go give Jew pipol, ofisas and di govnor for di 127 aria for di kingdom wey start from India go rish Kush. Dem rite dis kommand go give di pipol for dia aria akordin to di language wey dem dey speak.
EST 8:10 Mordekai rite am with King Zazes name kon stamp am with di king ring, den e send dem thru messenjas wey sabi ride horse fast-fast.
EST 8:11 Di king give Jew pipol for di town, di pawa to gada and protet demsef, so dat dem nor go fit distroy and kill dem. Dem fit fight anybody wey won kon attack dem kon pak dia propaty.
EST 8:12 Na di thirtint day for di twelft mont wey bi Adar, na-im dem choose for Jew pipol to do dis tin for King Zazes kingdom.
EST 8:13 Dem sey make dem read one kopy for di law for evry aria give all di pipol, so dat Jew pipol go dey ready for dat day, to fight dia enemies.
EST 8:14 Di messenjas wey dey ride di king horse kon go with di king law. And na for Shushan wey bi di main town dem for read di law.
EST 8:15 Mordekai wear royal garment wey dem make with purpol and white, with one fine crown kon komot from di king present.
EST 8:16 Jew pipol kon dey happy well-well and belle sweet dem.
EST 8:17 For evry aria for di kingdom where dem for read di kommand, di Jew pipol for der go take holy day kon do party with happiness. In-short, many pipol kon turn to Jew, bikos dem dey fear di Jew dem naw.
EST 9:1 Wen di thirtint day for di twelft mont (wey bi Adar mont) rish, di day wey dem suppose do wetin di king tok. Na dis day Jew enemies tink sey dem go distroy Jew pipol finish. Instead na Jew pipol kon distroy dia enemies.
EST 9:2 For anywhere wey Jew pipol dey start for di town, dem kon gada demsef to fight anybody wey won fight dem. Pipol for evriwhere dey fear dem and nobody gri near dem at-all.
EST 9:3 All di oga for di arias, di shiefs, di govnors and doz wey dey work for di king kon dey assist Jew pipol, bikos dem dey fear Mordekai.
EST 9:4 Dem kon know Mordekai for evriwhere, bikos en pawa for di palis, dey strong evriday.
EST 9:5 So Jew pipol attack all dia enemies with swod kon kill dem well-well. Dem do wetin dem like with dia enemies.
EST 9:6 Jew pipol kill five hundred men inside Shushan wey bi di main town.
EST 9:7 Dem still kill Parshandata, Dalfon, Aspatah,
EST 9:8 Porata, Adalia, Aridatah,
EST 9:9 Parmashta, Arisai, Aridai, and Vaizata.
EST 9:10 Dis na Haman wey Hammedata born, wey bi Jew pipol enemy, ten sons. But even as Jew pipol dey do all dis tins, dem nor ever tif or karry any propaty.
EST 9:11 For dat same day, dem kon go tell di king about di pipol wey dem kill for Shushan.
EST 9:12 Den di king tell Kween Estha, “For only Shushan, Jew pipol don kill five hundred men and Haman ten sons! How many dem go don kill for oda aria? So wetin yu still wont? Make yu tell mi and I go do am for yu.”
EST 9:13 Estha ansa, “If di king go agri, tumoro, make Jew pipol for Shushan still do wetin dem do today kon hang Haman ten sons body.”
EST 9:14 Di king kon orda sey make dem do am and dem read di law for Shushan, den dem hang Haman sons body.
EST 9:15 For di fourteent day for di twelft mont wey bi Adar, Jew pipol wey dey Shushan kon gada go kill anoda three hundred pipol for di town, but dem nor tosh or tif dia propaty.
EST 9:16 Di Jew pipol for di oda aria still gada defend demsef kon kill 75,000 of dia enemies, but dem nor tif or karry dia propaty.
EST 9:17 Dis tin happen for di thirtint day for di twelft mont wey bi Adar. Den, dem stop to kill for di fourteent day kon do party.
EST 9:18 Di Jew pipol for Shushan kon rest for di Fifteent day, bikos dem take di thirtint and fourteent day take kill dia enemies.
EST 9:19 Dis na why Jew pipol wey dey stay small-small town dey celebrate di fourteent day for di twelft mont wey bi Adar mont, as betta holy day to give gift, food and oda betta tins.
EST 9:20 Mordekai rite dis tins kon send am to all Jew pipol wey dey di kingdom, weda dem dey near or far sey,
EST 9:21 “For evry year, make una take holy day and celebrate for di fourteent and Fifteent day for Adar, wey bi di twelft mont,
EST 9:22 bikos na doz days Jew pipol take win dia enemies. Na den dia problem and wahala turn to smile and happiness.” Doz days go bi wen Jew pipol free diasef from dia enemies, so dem go share gifts among demsef and dash poor pipol gifts too.
EST 9:23 So Jew pipol obey Mordekai and dis celebrashon kon bi tradishon.
EST 9:24 Haman wey Hammedata from Agag born wey bi Jew pipol enemy, bin make plans to distroy Jew pipol. E don trow dice to choose day wen dem go kill and distroy dem.
EST 9:25 But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.
EST 9:26 Dis na why dem dey koll di holy day “Purim” wey mean, “To trow dice.” So, bikos of Mordekai leta and wetin don happen to dem,
EST 9:27 Jew pipol kon make law for demsef, dia shidren-shidren and any oda pesin wey go turn to Jew sey, for di rite time for evry year, dem must observe dis two days akordin to wetin Mordekai rite.
EST 9:28 Dem agri sey evribody wey bi Jew for di kingdom must obey dis kommand about “Purim” from one generashon go anoda.
EST 9:29 Den Kween Estha wey bi Abihail dota, still support evritin wey Mordekai rite about “Purim.”
EST 9:30 Dem send di kommand go give Jew pipol for di 127 aria wey King Zazes dey rule. Di kommand na to let Jew pipol know sey dem go get peace and dey save
EST 9:31 and make dia shidren-shidren obey “Purim law” for di korrect time, just as dem dey follow di fasting and mourning laws. Na Mordekai and Kween Estha kommand dem like dis.
EST 9:32 Evritin wey Estha kommand about Purim law, dem rite am for di offisial book.
EST 10:1 Di pipol wey dey near di sea for di kingdom, King Zazes kon force dem dey work well-well.
EST 10:2 Naw, all di great and wonderful tins wey e do, with how e take promote Mordekai, dem rite dem for Media and Persia kings book.
EST 10:3 So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
JOB 1:1 E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.
JOB 1:2 E born seven sons and three dotas.
JOB 1:3 E till get 7,000 sheep, 3,000 kamel, 500 oxen, 500 donkey wey bi woman, plenty savant and na-im get money pass for di east side for di kountry.
JOB 1:4 Job sons dey always do party one-by-one for dia house, wey evribody dey kom chop and drink and dia three sistas dey kom too.
JOB 1:5 One dia party finish, Job go koll and santify dem. For early morning, Job go offa sakrifice for all of dem. “Bikos e bilive sey dem fit nor know sey dem don sin and curse God.” Job dey do dis tin evritime.
JOB 1:6 Naw, wen di day rish for God angels to gada before God, Satan follow dem kom too.
JOB 1:7 God ask Satan, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
JOB 1:8 God kon tell Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for di eart; e dey klean and e good well-well. E dey fear mi well-well and e nor dey do bad tins.”
JOB 1:9 Satan ansa, “Job go gri woship Yu, if e nor get anytin wey e go gain? Yes, Job get good rizin to fear God.
JOB 1:10 Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals.
JOB 1:11 Just take evritin wey e get from am and e go curse Yu for yor face!”
JOB 1:12 God kon tell Satan, “Okay, evritin wey Job get, dey for yor hand, but make yu nor kill-am!” So Satan komot from God present.
JOB 1:13 One day, Job shidren dey do party for dia senior broda house,
JOB 1:14 den leta, one savant run go tell Job sey, “Oga! Wi dey klear di land with yor melu and di donkey dem dey for di oda side,
JOB 1:15 den at wons, Sabean pipol just kom attack and karry all of dem go. Dem kill all di savant and na only mi one eskape kom tell yu.”
JOB 1:16 As e still dey tok, anoda savant run kom kon sey, “Oga! God fire fall kom from heaven kon kill all di sheep and doz wey dey guide dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
JOB 1:17 As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
JOB 1:18 Before e tok finish, anoda savant run kom kon sey, “Yor shidren dey do party for dia senior broda house,
JOB 1:19 den one kind strong breeze from di wildaness blow di house fall kon kill all of dem. Naw, na only mi one eskape kom tell yu.”
JOB 1:20 Den Job stand up, tear en klot; barb en hair kon fall face groun.
JOB 1:21 Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”
JOB 1:22 With all dis tins wey dey happen so, Job nor ever blame, sin or curse God.
JOB 2:1 For anoda day, wen God angels gada before God again, Satan sef follow dem kom too.
JOB 2:2 God kon ask am, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
JOB 2:3 God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”
JOB 2:4 Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die.
JOB 2:5 Make Yu allow mi wound en body, den e go curse Yu for yor face!”
JOB 2:6 God kon tell Satan, “Evritin dey for yor hand, but make yu nor kill-am.”
JOB 2:7 So Satan live where God dey kon pak sore full Job body.
JOB 2:8 Job sidan outside near dirty kon use breaki-breaki pot take dey skrape en sore.
JOB 2:9 En wife kon tell am, “Yu still dey respet dis God? Just curse am make yu die!”
JOB 2:10 But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
JOB 2:11 Job three friends hear wetin dey happen to am, so dem kon sey dem go-go greet am. Dia names na Elifaz from Teman, Bildad from Shuh and Zofar from Naamah.
JOB 2:12 As dem kom, dem si Job from far, but dem nor sey na-im. Wen dem si sey na en, dem kon start to kry; dem tear dia klot kon pak san full dia head.
JOB 2:13 Dem sidan with am for seven days and seven nite. Nobody fit tok, bikos dem si as en kondishon bi.
JOB 3:1 As last, Job kon tok and e curse di day wey dem born am.
JOB 3:2 Job kon sey,
JOB 3:3 “Make di day wey my mama born mi disappear and make di nite wey e get my belle, vanish!
JOB 3:4 Make di day turn to darkness. God! Make Yu nor remember dat day again; nor let lite shine put again.
JOB 3:5 Make darkness and deat shadow kover am! Make betta kloud dey on-top am; make darkness kover en lite.
JOB 3:6 Make dat nite komot from kalendar; make dem nor kount am join di days and monts for di year again.
JOB 3:7 Make di nite empty and e nor go get joy again.
JOB 3:8 Make di pipol wey dey curse day, curse am! Make di pipol wey dey curse wota juju, curse am too.
JOB 3:9 Make en morning star remain darkness. Even wen e find lite, make e nor si am and make en day nor break.
JOB 3:10 Make Yu curse di day wey my mama born mi, bikos na-im make mi dey face all dis trobol so o-o.
JOB 3:11 “Wetin make mi nor die before my mama born mi? Or why I nor die as I just kom out from my mama belle?
JOB 3:12 Wetin make my mama karry mi for en lap? Why my mama feed mi with en breast?
JOB 3:13 If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
JOB 3:14 with kings and govnors wey bin build big-big house for demsef for dis eart.
JOB 3:15 I for dey rest with prince wey get gold and wey silva full dia palis.
JOB 3:16 Why dem nor beri mi like pikin wey die before dem born am? Like pikin wey nor live to si di lite?
JOB 3:17 Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil and evribody wey dey der, dey rest.
JOB 3:18 Even di pesin wey dey prison before, dey rest, bikos nobody dey opress am for der.
JOB 3:19 Evribody dey der, both small and big and even savants dey free from dia oga.
JOB 3:20 “Wetin make God dey give lite to pesin wey dey sofa? Why E dey give life to doz wey dey face trobol?
JOB 3:21 Dem dey find deat, but dem nor dey si am; dem dey find am pass wetin dey precious.
JOB 3:22 Dem dey-dey happy wen dem die go dia grave.
JOB 3:23 Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro, pipol wey God surround with wahala?
JOB 3:24 Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.
JOB 3:25 And naw, evritin wey I dey fear, don dey happen to mi so o-o.
JOB 3:26 I nor get peace or rest and my trobol nor gri end.”
JOB 4:1 Elifaz from Teman kon sey:
JOB 4:2 “Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again.
JOB 4:3 Si, yu don tish many pipol and give strent to doz wey dey weak.
JOB 4:4 Yor words don support pipol wey won fall and yu don give strent to doz wey don taya.
JOB 4:5 Naw wey e rish yor turn to face trobol, yu nor get heart again. Yu nor fit stand am at-all.
JOB 4:6 Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.
JOB 4:7 Make yu tink am sef, den tell mi wish time pesin wey dey respet God, dey sick.
JOB 4:8 But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.
JOB 4:9 God dey skata doz kind pipol, bikos E dey vex for dem.
JOB 4:10 Wiked pipol dey do like lion, but God go skata and break dia tit.
JOB 4:11 Dem go die like lion wey nor si food chop and all dia shidren go skata.
JOB 4:12 My savant kom tell mi word small-small, but I nor hear wetin e tok well.
JOB 4:13 E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep.
JOB 4:14 I fear and all my body kon dey shake.
JOB 4:15 Na small breeze blow my face kon make my hair stand.
JOB 4:16 Sometin stand for der and even wen I look, I nor fit si wetin e bi.
JOB 4:17 E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?
JOB 4:18 If God nor even bilive en savants wey dey heaven; dey si komplain for en angels body,
JOB 4:19 yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house?
JOB 4:20 Somebody fit dey alive for morning kon die for nite, before odas go know.
JOB 4:21 Dem go take evritin wey e get and e die without wisdom.
JOB 5:1 “Job, make yu koll naw, if anybody go ansa yu? Na who dey holy wey yu won go meet?
JOB 5:2 Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
JOB 5:3 I don si sey fool fit dey progress, but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get.
JOB 5:4 Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt.
JOB 5:5 Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.
JOB 5:6 Evil nor dey grow from dust or trobol from groun.
JOB 5:7 But just as lite dey shine go up, na so too dem born pesin enter trobol.
JOB 5:8 “But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am.
JOB 5:9 Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.
JOB 5:10 E dey give rain to di eart and wota for di san.
JOB 5:11 Na God dey karry doz wey dey honbol go up and give joy to doz wey dey mourn.
JOB 5:12 E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan!
JOB 5:13 E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.
JOB 5:14 Dem dey waka for darkness for day time. For aftanoon, dem dey waka dey find road like sey dem dey darkness.
JOB 5:15 But na God dey save poor pipol from deat. E dey save doz wey nor get, from doz wey get pawa.
JOB 5:16 E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol.
JOB 5:17 Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.
JOB 5:18 God go kover where E for wound yu; na en hand wound yu and na dat same hand E go take heal yu.
JOB 5:19 E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.
JOB 5:20 Wen honga kom, E go keep yu alive; wen war kom, E go protet yu, so dat yu nor go die.
JOB 5:21 God go diliver yu from trobol; E go save yu wen distroshon kom.
JOB 5:22 Yu go laf trobol and honga; yu nor go fear wiked animals again.
JOB 5:23 Di land wey yu klear go dey free from stones and wild animals nor go kom near am.
JOB 5:24 Peace go dey yor house and wen yu look yor propaty, evritin go komplete.
JOB 5:25 Yu go get many shidren! Dem go plenty like grass for dis eart.
JOB 5:26 Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die.
JOB 5:27 Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”
JOB 6:1 Den Job ansa:
JOB 6:2 “If dem put my trobol and pains for skale,
JOB 6:3 dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis.
JOB 6:4 God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
JOB 6:5 Donkey dey fear wen e dey chop grass? Abi melu dey kwayet wen e dey near food?
JOB 6:6 But who fit chop food wey nor get salt or taste? Or wish kind taste dey for di white part for egg?
JOB 6:7 I nor fit tosh dat kind food, bikos e dey make mi sick.
JOB 6:8 “Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?
JOB 6:9 I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.
JOB 6:10 Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word.
JOB 6:11 Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?
JOB 6:12 Na stone dem take make my strent? Abi my body na bronze?
JOB 6:13 I nor get strent to take help mysef and all my pawa don komot from my body.
JOB 6:14 “Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not.
JOB 6:15 But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!
JOB 6:16 Di wota dark bikos ice-blok and snow don kover dem.
JOB 6:17 But wen hot weda kom, di wota go disappear. Wons heat dey, di wota go vanish from where dem dey.
JOB 6:18 Animals wey dey pul karavan waka lost, bikos dem dey find wota and dem waka die for dry land.
JOB 6:19 Animals wey dey pul karavan wey kom from Sheba and Tema nor find dem,
JOB 6:20 but all dia hope die for dry river.
JOB 6:21 To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake.
JOB 6:22 “I don ever sey, ‘Make una give mi sometin, or make una give money to pesin for mi?
JOB 6:23 Or make una save mi from my enemy pawa and from wiked pipol?’
JOB 6:24 “Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.
JOB 6:25 True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.
JOB 6:26 My own word wey bi true nor dey good, but na di yuzles words yu like.
JOB 6:27 Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.
JOB 6:28 Make yu look mi for face, I nor go lie give yu.
JOB 6:29 Yu don try well-well, stop to tink bad tins Nor kondemn mi again, bikos I dey rite.
JOB 6:30 Yu feel sey I dey lie? Yu feel sey I nor know rite from wrong?
JOB 7:1 “Evritin wey man dey do for dis life nor bi struggol? Abi awa days nor bi like savant wey dem hire to work?
JOB 7:2 Like savant wey dey wait make nite kwik kom; like worker wey dey wait make dem pay am.
JOB 7:3 Mont to mont, I nor get anytin to live for; evry nite dey kause pain for mi.
JOB 7:4 Wen I sleep, I dey tink dey sey, ‘Wen day go take break?’ I dey waka for nite dey wait make day break.
JOB 7:5 Worm don full my body, sickness don kover my body with dirty; my body don skata with sore.
JOB 7:6 My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope.
JOB 7:7 My God! Make Yu remember sey my life bi like breeze and my happiness don end.
JOB 7:8 Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go.
JOB 7:9 As kloud dey vanish, na so who die nor dey kom back again.
JOB 7:10 E nor go ever kom back to en house and nobody go si am again.
JOB 7:11 “No! I nor go fit klose my mout; I dey vex for my spirit, so I must tok. I must tok as e dey pain mi for my mind.
JOB 7:12 Why Yu put mi for kage make pipol dey look mi? I bi wota juju?
JOB 7:13 Make I sey my bed go give mi rest and my pillow go reduce my komplain?
JOB 7:14 But Yu still dey make mi fear for dream; yor vishon dey make mi fear well-well.
JOB 7:15 E betta make I kill mysef, dan dis kind wiked life wey I dey live.
JOB 7:16 I don taya for life; I nor go live forever. Abeg make yu live mi, bikos my life nor good.
JOB 7:17 “Wetin bi man wey Yu dey worry for? Why Yu dey borda yorsef with di tin wey Yu kreate?
JOB 7:18 Yu dey visit am for morning and evritime, Yu won try or test am.
JOB 7:19 Nor look mi again, make Yu leave mi alone, so dat I go swallow my own spit.
JOB 7:20 Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu?
JOB 7:21 Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
JOB 8:1 Bildad wey kom from Shuah kon sey:
JOB 8:2 “Job, wen yu go stop to dey tok like dis, wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
JOB 8:3 Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
JOB 8:4 Yor shidren go don sin against God, naim make am pay dem for dia sin.
JOB 8:5 But if yu look up to God kon beg di Oga wey dey mighty;
JOB 8:6 if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.
JOB 8:7 Yor biginnin fit dey small for eye naw, but yor ending go betta well-well.
JOB 8:8 Make yu ask generashons wey don pass; tink and follow di trut wey dem sabi;
JOB 8:9 bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.
JOB 8:10 But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:
JOB 8:11 Papyrus plants fit grow for where river nor dey? Abi reed fit grow without wota?
JOB 8:12 If wota dry, na dem go first die wen e neva rish to kut or use dem.
JOB 8:13 Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.
JOB 8:14 Dem bilive bad-bad tins and dia sekurity bi like spider house.
JOB 8:15 If dem rest for spider house, e go fit hold dem? If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
JOB 8:16 Wiked pipol plenty like betta grass for sun wey dem dey wota, wey skata around di gardin.
JOB 8:17 Dem wrap dia rut for plenty stone kon dey look for where dem go hide put for di rock.
JOB 8:18 But if dem rut dem komot for dia place, dat place go rijet dem kon sey, ‘I neva si una before!’
JOB 8:19 Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get and from inside di eart, odas go kom take dia place.
JOB 8:20 But God nor go ever help wiked pipol kon let pesin wey dey fear am, sofa.
JOB 8:21 E go pak laf full yor mout and yor lip go dey happy.
JOB 8:22 But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”
JOB 9:1 Den Job ansa:
JOB 9:2 “Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?
JOB 9:3 Wetin go make pesin argue with God? E go fit ask God kweshon wey E nor go fit ansa?
JOB 9:4 God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.
JOB 9:5 E dey move mountins anytime E wont kon skata dem with vexnashon.
JOB 9:6 God wey shake di eart komot from where e dey! E shake di pilas wey support di eart.
JOB 9:7 Di One wey kommand di sun and di sun nor raiz; di stars sef nor shine for nite.
JOB 9:8 Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.
JOB 9:9 Na God make di Bear, Orion, di Pleiades and di sky for sout.
JOB 9:10 Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.
JOB 9:11 Even if God pass naw, I nor go fit si am. If e waka pass, I nor go even smell am sef.
JOB 9:12 Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take. Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’
JOB 9:13 If God dey vex, nobody go fit stop am. Even juju for wota dey under en leg.
JOB 9:14 “So, na how I won take find word take ansa God?
JOB 9:15 Even if I nor do any bad tin, di only tin wey I fit still do na to beg for mesi from God wey bi my judge.
JOB 9:16 Even if I koll am and E ansa mi, I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.
JOB 9:17 E send breeze kom attack and wound mi, even doh I nor do any bad tin.
JOB 9:18 E nor let mi breath well; E don kover my life with bitterness.
JOB 9:19 Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?
JOB 9:20 I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.
JOB 9:21 I know kare again, life don taya mi, bikos I know sey I nor do any bad tin.
JOB 9:22 “All of dem na di same! Na dis make mi dey sey, E dey distroy both who nor do anytin and di ones wey dey do bad tins.
JOB 9:23 Wen pesin wey nor do bad tin die like dat, God go just dey laf.
JOB 9:24 God don give dis eart to wiked pipol kon kover all di judge dem face. If nor bi en do am, den na who fit?
JOB 9:25 “No day good for my life since dem born mi and dem nor dey last.
JOB 9:26 My life just dey rush pass like speed boat; like eagle wey won katch rabbit.
JOB 9:27 If I tok sey I go forget my komplain or I go try to dey happy,
JOB 9:28 my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.
JOB 9:29 If I dey guilty, wetin go make mi komplain?
JOB 9:30 Even if I use soap wosh my body and make my hand klean well-well,
JOB 9:31 Yu go still trow mi put for dirty pit and even di klot wey I wear, go rijet mi.
JOB 9:32 If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.
JOB 9:33 Nobody fit setol us! Nobody go fit setol mi and my God.
JOB 9:34 Who go fit stop god make E nor ponish mi again, so dat e nor go make mi fear again.
JOB 9:35 Den I nor go fear as I dey tok, but naw, nor bi so e bi with mi.
JOB 10:1 “Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish.
JOB 10:2 I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
JOB 10:3 E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do?
JOB 10:4 “Yu dey si tins di wey wi dey si dem? Abi Yu get di kind eye wey human being get?
JOB 10:5 Yor life short like awa own? Abi yor years know long life awa own.
JOB 10:6 Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?
JOB 10:7 Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.
JOB 10:8 “Na di same hand wey Yu take make mi, Yu won take skata mi?
JOB 10:9 Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again?
JOB 10:10 Na yor pawa my papa take born mi; na Yu make mi grow for my mama belle.
JOB 10:11 Yu make my body with bone kon kover am with flesh and skin.
JOB 10:12 Yu don give mi life kon show mi yor love wey nor dey die. Na bikos yu kare for mi naim make mi still dey alive.
JOB 10:13 But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi.
JOB 10:14 Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
JOB 10:15 If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so.
JOB 10:16 If I sey make I karry body up, Yu go porshu mi like lion and na mi Yu go use take show yor pawa.
JOB 10:17 Yu must get pipol wey go tok against mi; yor vexnashon dey big evriday by day and na new attack Yu always dey plan for mi.
JOB 10:18 “God! Why Yu let my mama born mi? I for don die, before anybody si mi.
JOB 10:19 To die for my mama belle, for betta pass dis one wey I dey so.
JOB 10:20 Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get.
JOB 10:21 I go soon go di land where Yu nor go fit si mi and I nor go kom back again.
JOB 10:22 I go-go di dark place where dead pipol and konfushon dey. Place where lite nor dey-dey.”
JOB 11:1 Zofar wey kom from Naamah kon tell Job:
JOB 11:2 “So nobody won ansa all dis nonsense wey yu dey tok? Na bikos yu too tok make yu feel sey yu dey rite?
JOB 11:3 Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?
JOB 11:4 Yu sey, ‘My tishing dey pure and I dey klean for God eye.’
JOB 11:5 But I wish sey God go just ansa and open en mout against yu.
JOB 11:6 E go show yu sey wisdom get many side. Wisdom nor bi simpol matter. God nor even ponish yu rish as yor sin many rish.
JOB 11:7 Yu fit find out where God from kom? Or how E take dey get en mighty and strong pawa?
JOB 11:8 God high pass di heavens; so wetin yu go fit do? E deep pass where dead body der; so wetin yu feel sey yu know?
JOB 11:9 God big pass di eart and E wide pass di sea.
JOB 11:10 If God arrest and put pesin for prison or karry am go kourt, na who won stop am?
JOB 11:11 God know pipol wey dey lie; E dey si all di sins wey dem dey kommit.
JOB 11:12 Pesin wey nor get sense, nor go fit wise unless donkey go fit born human being.
JOB 11:13 But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.
JOB 11:14 If yu dey hide do wiked and bad tins, make yu stop am.
JOB 11:15 Na dat time yu go fit face di world without fear and yu go dey innocent.
JOB 11:16 Dat time all yor trobols go vanish like wota wey dey flow pass and dem nor go remember am again.
JOB 11:17 Yor life go shine pass aftanoon sun and di dark hours for life, go give yu morning lite.
JOB 11:18 Bikos wi get hope, yor life go dey well; God go protet and give yu rest.
JOB 11:19 Yu nor go fear yor enemies again and pipol go dey kom beg yu for help.
JOB 11:20 But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
JOB 12:1 Den Job ansa:
JOB 12:2 “True-true, una know pass evribody. So wen una die, wisdom go follow una die too.
JOB 12:3 But I get sense as yu get too. E nor get how yu take betta pass mi, bikos evribody know evritin wey yu dey tok.
JOB 12:4 Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.
JOB 12:5 Yu nor get trobol, but yu still dey laf mi; pesin wey won fall before, yu don kuku nak am make e for kwik-kwik fall.
JOB 12:6 But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace, even doh na God hand dem dey.
JOB 12:7 “Even bird and animals get many tins wey dem go tish yu.
JOB 12:8 Make yu ask di eart and sea make dem kom tish yu wisdom.
JOB 12:9 All of dem know sey na God by ensef dey kause all dis wahala for mi,
JOB 12:10 bikos na God hand dey hold di eart and evribody dey alive bikos of en pawa.
JOB 12:11 But as yor tongue dey taste food, na so too yor ear dey hear word.
JOB 12:12 Old pipol get wisdom? Abi long life nor dey bring undastandin?
JOB 12:13 But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins.
JOB 12:14 Wen God skata, who go fit build am again? And who go fit free pesin wey God put for prison?
JOB 12:15 Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall and river go only flow wen God gi-am wota.
JOB 12:16 Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand.
JOB 12:17 E dey make leaders bihave like fools kon take wisdom from rulers hand.
JOB 12:18 E dey remove kings from dia throne kon make dem prisonas.
JOB 12:19 E dey honbol priests and ova-trow doz wey dey pawa.
JOB 12:20 E take di wisdom wey old pipol get kon silent doz wey dey advise odas.
JOB 12:21 E disgrace princess kon take pawa komot from rulers hand.
JOB 12:22 E open all di sekret tins wey dem hide for darkness kon put lite for where deep pass.
JOB 12:23 Na-im dey give nashons pawa kon still skata dem again.
JOB 12:24 E make leaders bi like fools kon make dem waka lost for desert.
JOB 12:25 Dem dey waka find road for darkness. E make dem stagga like man wey don drink well-well.
JOB 13:1 “True-true, my eyes don si all dis tins, my ear don hear dem and I undastand dem well.
JOB 13:2 Wetin yu know, I know am too. Mi and yu na di same.
JOB 13:3 But I wish sey I fit tok to God, nor bi yu. I won make mi and God setol dis matter.
JOB 13:4 Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.
JOB 13:5 If to sey yu just kwayet, dat for bi wisdom for yu.
JOB 13:6 So naw make yu listin to my words; listin as I dey beg.
JOB 13:7 Yu won use lie defend God? Abi all dis yor wayo argument na to help God?
JOB 13:8 Abi yu dey try to tok for am? Na yu won tok for God?
JOB 13:9 If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
JOB 13:10 Even if yu dey pritend sey yu dey sorry for mi, God go still katch and ponish yu.
JOB 13:11 Abi en pawa nor go make yu fear? Yu sure sey di fear nor go kill yu so?
JOB 13:12 Di words wey yu dey tok nor dey good at-all, dem dey yuzles like ashes; dem dey skata for groun like klay.
JOB 13:13 Make yu shut up yor mout, so dat I go tok. Wetin go bi, go bi.
JOB 13:14 Why I dey risk my life like dis? Why I dey take decision for mysef?
JOB 13:15 Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
JOB 13:16 E fit bi sey my boldness fit save mi, bikos know wiked pesin go try sey e won face God.
JOB 13:17 Naw, make yu listin to wetin I dey try to tok; make yu open yor ear well.
JOB 13:18 I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
JOB 13:19 Anybody fit argue with mi for dis matter? But if Yu sey I dey wrong, I go kwayet till I die.
JOB 13:20 Abeg make I ask for two tins and make Yu do dem for mi, den I nor go hide from Yu.
JOB 13:21 Make Yu remove yor hand from my life and nor make mi fear again.
JOB 13:22 God, make Yu koll mi and I go ansa or make I tok, so dat Yu go ansa mi?
JOB 13:23 Wish kind sin I kommit sef? Wish kind bad tin I do? Wish kind wrong tin Yu sey I do?
JOB 13:24 Why Yu dey hide from mi? Why Yu dey trit mi like sey I bi yor enemy?
JOB 13:25 Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight? Abi na dry leaf Yu won porshu?
JOB 13:26 Yu just dey rite bad tins against mi; even di ones wey I kommit wen I bi small pikin.
JOB 13:27 Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go, Yu dey wosh mi.
JOB 13:28 Naw, I don turn rotin wood and I bi like klot wey worm chop anyhow.
JOB 14:1 “Na short life na-im man wey woman born get and na trobol full am.
JOB 14:2 Wi dey grow and dry kwik-kwik like flower; wi dey vanish like shadow and nor-tin dey remain.
JOB 14:3 Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so?
JOB 14:4 No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.
JOB 14:5 Yu know as human being life bi from di biginnin. Even di nomba of dia days wey dem go live, Yu don setol am and Yu nor dey shange.
JOB 14:6 So make Yu live us alone make wi rest! Wi bi like pipol wey dem hire to work, so allow us finish awa work with peace.
JOB 14:7 “Tree wey dem don kut for groun get hope, bikos e fit still grow again and e nor go die.
JOB 14:8 Even if di rut don old and dia part dem don dey die,
JOB 14:9 wen wota tosh am, e go grow like seed wey dem just plant.
JOB 14:10 But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?
JOB 14:11 Like wota wey stop to flow and river wey dry,
JOB 14:12 na so too pipol wey die nor go kom back again. Dem nor go fit si di sky for day time again, bikos dem don sleep go.
JOB 14:13 “I wish sey Yu go hide mi for where dead body dey; den wen Yu nor dey vex again, Yu go remember mi.
JOB 14:14 If pesin don die, e fit kom back to life? But I go wait for betta time wen dis trobol don pass mi.
JOB 14:15 Den, Yu go koll and I go ansa and Yu go kon like mi wey Yu use yor hand take make.
JOB 14:16 “Naw, bikos na Yu dey kount my steps, Yu nor go kount my sins again.
JOB 14:17 Yu go forgive and kover my sins. Yu go tie dem put for bag.
JOB 14:18 Just as mountin dey fall and rocks dey move from where dem dey.
JOB 14:19 Just as wota dey wosh stone klean and heavy rain dey wosh di san, na so too Yu take distroy awa hope for life.
JOB 14:20 Yor pawa strong pass awa own. Yu porshu us komot for dis life. Wen wi die, Yu dey make us resemble anoda tin.
JOB 14:21 Even if awa pikin win award, wi nor go know, bikos wen pesin don die, e nor dey know wetin dey happen again.
JOB 14:22 But en body go pain am and en soul go kry for am.”
JOB 15:1 Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
JOB 15:2 “Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?
JOB 15:3 No wise pesin go tok as yu dey tok so or sey en dey rite with en yeye words?
JOB 15:4 Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?
JOB 15:5 Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.
JOB 15:6 E nor get any nid for mi to kondemn yu; bikos only yor words don kondemn yu.
JOB 15:7 Na yu bi di first man wey dem born? Dem don born yu before God kreate di mountins?
JOB 15:8 Yu dey hear di plans wey God dey make? Na only yu get human being sense?
JOB 15:9 Wetin yu tink sey yu know wey wi nor know? Wetin yu feel sey yu undastand, wey wi nor undastand?
JOB 15:10 Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
JOB 15:11 God konfort too small for yu? Abi en gentol words nor rish for yu?
JOB 15:12 Wetin make yu nor dey rizin well again? Wetin make yor eyes dey weak,
JOB 15:13 sotey yu dey tok all dis kind words, bikos yu dey vex for God?
JOB 15:14 Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?
JOB 15:15 God nor even bilive en own angels, bikos dem nor klean rish for en eye,
JOB 15:16 how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
JOB 15:17 If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
JOB 15:18 Pipol wey get sense don tish mi trut wey dem learn from dia papa;
JOB 15:19 doz wey God give di land before any strenja kon stay with dem.
JOB 15:20 Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
JOB 15:21 Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
JOB 15:22 Dem nor get hope to kom out from darkness, bikos swod dey wait to kill dem trowey.
JOB 15:23 Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
JOB 15:24 Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
JOB 15:25 bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
JOB 15:26 Dem hold dia strong swod dey won fight di Oga God.
JOB 15:27 Dis wiked pipol big and dem dey prosper; dia waist fat well-well too.
JOB 15:28 But dia towns go skata. Dem go stay for abandon house wey don near skata.
JOB 15:29 Dia money nor go tey for dia hand and nor-tin wey dem get, go last. Even dia propaty go finish.
JOB 15:30 Dem nor go fit run from darkness; dem go bi like tree wey en branches don burn finish and dem go skata as God breath.
JOB 15:31 If dem nor get sense rish and dem kon dey bilive bad tins, na di bad tins go follow dem.
JOB 15:32 Dem go die finish before dia time go rish den dia branches nor go ever green again for life.
JOB 15:33 Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits; like olive tree wey lost en beauti.
JOB 15:34 Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all and na fire go burn di house wey dem build with wayo money.
JOB 15:35 Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”
JOB 16:1 Job ansa:
JOB 16:2 “I don hear many words like dis before. Yor konfort na more trobol for mi!
JOB 16:3 All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu? Wetin make yu still dey ansa mi?
JOB 16:4 If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu.
JOB 16:5 But fit to sey na mi I for enkourage yu. I go try reduce yor pains.
JOB 16:6 “But e nor get wetin I go tok give yu, wey fit help mi and even if I kwayet, e nor go remove my pains.
JOB 16:7 My Oga God, true-true, Yu don kill my full family and Yu don make life taya mi.
JOB 16:8 Yu don seize and turn mi to yor enemy. Na skin and bone I bi and pipol dey use am against mi.
JOB 16:9 God don skata mi, bikos E dey vex. E tear mi with en tit and dey look mi one kind.
JOB 16:10 Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
JOB 16:11 God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand.
JOB 16:12 I dey live for peace before, but God don skata mi. E seize mi for my neck kon skata my life. E dey plan against mi.
JOB 16:13 E dey shot mi with en arrow from difren direcshon. E nor sorry for mi wen E dey wound mi and na my blood wet di groun.
JOB 16:14 E wound mi many times. E attack mi like soja wey hate pesin.
JOB 16:15 I dey mourn with sak klot and I use san take kover my face.
JOB 16:16 I kry sotey my eyes don dey red and swell-up and naw, na only darkness I dey si.
JOB 16:17 I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin.
JOB 16:18 “Dis groun, na beg I dey beg yu, make yu nor kover di bad tins wey dey happen to mi; nor kwayet naw wen I dey kry for help!
JOB 16:19 I know sey pesin dey for heaven wey go stand fight for mi.
JOB 16:20 My friends dey tok against mi and I dey kry give God.
JOB 16:21 Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God, just as pesin dey beg en friend.
JOB 16:22 My years nor plenty again and I go soon go where I nor go fit kom back again.
JOB 17:1 “My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.
JOB 17:2 Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
JOB 17:3 God, make Yu show sey I dey innocent, bikos nobody gri bilive or fight for mi.
JOB 17:4 Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi.
JOB 17:5 Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.
JOB 17:6 Naw, God don make pipol dey laf mi; dem dey kom spit for my face.
JOB 17:7 My eyes don swell-up bikos of kry; my body don tin like broom.
JOB 17:8 Good pipol dey shok wen dem si mi. Doz wey dey innocent go tok against doz wey nor dey fear God.
JOB 17:9 But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.
JOB 17:10 “But if all of dem kom follow mi stand, I nor go even si one wey wise.
JOB 17:11 My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again.
JOB 17:12 But my friends don turn nite to day; dem sey lite don near, but na darkness I dey si.
JOB 17:13 My only hope na where dead body dey, where I go for go sleep for darkness.
JOB 17:14 If I sey, ‘Grave na my papa’ and di worm wey dey chop mi, ‘Na my mama and sistas,’
JOB 17:15 any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?
JOB 17:16 No, my hope go follow mi wen I dey go where dead body dey? Wi go-go grave togeda?”
JOB 18:1 Bildad wey kom from shuh kon sey:
JOB 18:2 “Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.
JOB 18:3 Wetin make yu dey feel sey wi nor get sense like animals?
JOB 18:4 Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
JOB 18:5 Wiked pipol lite go soon off; dia fire nor go ever burn again.
JOB 18:6 Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
JOB 18:7 Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
JOB 18:8 Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.
JOB 18:9 Trap go katch dia leg kon hold dem for der.
JOB 18:10 Dem hide rope for dem for groun kon set trap for where dem go waka pass.
JOB 18:11 Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
JOB 18:12 Sofa dey hongry dem; wahala dey wait for dem to fall.
JOB 18:13 Sickness don chop dia body finish and na dis make dia hands and legs dey rotin.
JOB 18:14 Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
JOB 18:15 Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?
JOB 18:16 Dia rut don dry finish and dia branches go skata.
JOB 18:17 Pipol nor go remember dem for dia house or for outside again, bikos dia name don fade komot from di land.
JOB 18:18 Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.
JOB 18:19 Dem nor get shidren, grand-shidren or pesin wey go live afta dem don die.
JOB 18:20 From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,
JOB 18:21 ‘True-true, na so wiked pipol house dey bi and pipol wey nor know God, na dem dey stay dis kind place.’ ”
JOB 19:1 Job ansa:
JOB 19:2 “Bildad, na wen yu go stop to ponish and worry mi with yor words?
JOB 19:3 Yu don already curse mi rish ten times. Yu suppose to dey shame as yu dey trit mi like dis.
JOB 19:4 Even if I do bad tin, how dat one take koncern yu?
JOB 19:5 If yu feel sey yu betta pass mi kon dey use my trobol against mi,
JOB 19:6 den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.
JOB 19:7 “If I kry out bikos of dis trobol sef, nobody go ansa mi. I dey kry for help, but nobody dey hear am.
JOB 19:8 God don block my way and I nor fit pass; E don hide my way for darkness.
JOB 19:9 E don take all my glory kon distroy my respet.
JOB 19:10 E skata mi for evry side, until I nor get hope again.
JOB 19:11 God dey vex for mi, so E kount mi join en enemies.
JOB 19:12 En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
JOB 19:13 “God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
JOB 19:14 My family don go leave mi. My friends don forget mi.
JOB 19:15 Even di strenjas for my house don forget mi and my wimen savant dey do like sey na mi bi strenja.
JOB 19:16 Wen I koll my savant, e nor gri ansa, even wen I beg am with my own mout.
JOB 19:17 My wife nor fit stay where I dey breath and my own broda nor gri kom near mi.
JOB 19:18 Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
JOB 19:19 My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.
JOB 19:20 My bones just whole my skin and I just manage dey run with my life.
JOB 19:21 Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand.
JOB 19:22 Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi? Abi yu neva trobol mi rish?
JOB 19:23 “I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok, make e for rite dem for book!
JOB 19:24 Or make e karve and rite di words for stone, so dat dem go dey forever.
JOB 19:25 But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end.
JOB 19:26 Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.
JOB 19:27 I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all.
JOB 19:28 So wetin make yu dey akuiz mi dey sey, ‘Na yu kause di wahala wey yu dey face?’
JOB 19:29 But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”
JOB 20:1 Zofar still sey:
JOB 20:2 “Job! Yu dey make mi vex. Naw, I nor fit wait before I ansa.
JOB 20:3 All di tins wey yu dey tok since, na curse! But I know wetin to tell yu.
JOB 20:4 Yu know sey wen God first kreate human being,
JOB 20:5 wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.
JOB 20:6 Dem fit big well-well, dey great and dia head dey tosh heaven,
JOB 20:7 but God go blow all of dem trowey like dust. Pipol wey know dem before go sopraiz kon ask, ‘Where dem go?’
JOB 20:8 Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.
JOB 20:9 Pipol wey si dem before, nor go si dem again. Dia family nor go si dem again
JOB 20:10 and dia shidren go beg poor pipol; dem go pay back all wetin dia papa tif from poor pipol hand.
JOB 20:11 Dia smooth and betta body, go soon turn to dust.
JOB 20:12 Bikos bad tins sweet, dem kon keep some for dia mout
JOB 20:13 and bikos dem won enjoy di sweetness, dem nor gri komot am from dia mout.
JOB 20:14 But di food go betta like poizin for dia belle. E go bi like snake poizin inside dia body.
JOB 20:15 Wiked pipol go vomit di money wey dem tif. God go take am back with di ones wey dey dia belle.
JOB 20:16 Wetin wiked pipol swallow bi like poizin; e dey kill dem like who wiked snake bite.
JOB 20:17 Dem nor go live to si di river wey get olive or di one wey milk and honey full.
JOB 20:18 Dem must die leave evritin wey dem work for; dem nor go get shance to chop from dia money,
JOB 20:19 bikos dem don beat and kollect from pipol wey nor get. Dem still seize dia house,
JOB 20:20 bikos nor-tin dey rish dem, but wetin dem get nor go fit save dem.
JOB 20:21 Nor-tin dey remain for plate wey dem take chop; dat na why dia propaty nor dey last.
JOB 20:22 Wen dia propaty don dey plenty, trobol go kom skata and distroy am.
JOB 20:23 Make God feed dem beleful with trobol. Make God pour in vexnashon for dia head like evening rain dey fall.
JOB 20:24 Wen dem won run, bikos of iron swod, di bronze bow go shot dem fall.
JOB 20:25 As dem pul di arrow komot dia body, blood go rush kom out and fear go kill dem trowey.
JOB 20:26 Evritin wey dem don save, go skata. Fire wey pesin nor lite, na-im go kom burn dem die with dia family.
JOB 20:27 Heaven nor go kover dia sins and di eart go tok against dem.
JOB 20:28 Evritin wey dem get, God go distroy am with wota wen E dey vex.
JOB 20:29 Dis na wetin go happen to wiked pipol! Dis na wetin God go do dem.”
JOB 21:1 Job ansa:
JOB 21:2 “Make yu listin to wetin I dey tok. Dis na all di konfort wey I ask from yu.
JOB 21:3 Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
JOB 21:4 I dey komplain give human being? If I nor dey komplain give human being, wetin go make mi kwayet?
JOB 21:5 Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu! Make yu shok put yor hand for mout.
JOB 21:6 Wen I tink about wetin dey happen to mi, my body go dey shake, bikos of fear.
JOB 21:7 “Why God dey let wiked pipol live? Why E dey make dem old kon prosper?
JOB 21:8 Dem get shidren and grand-grand shidren and dem dey si as dia shidren dey grow.
JOB 21:9 God nor dey send trobol go skata dia house; dem nor dey live with fear.
JOB 21:10 All dia kattle dey get belle and born without trobol or wahala.
JOB 21:11 Dia shidren dey run and play like animal pikin wey nor get problem.
JOB 21:12 Dem dey dance, dey play sheke-sheke, harp and dey enjoy dia trumpet sound.
JOB 21:13 Dem dey live dia life for peace and dey die without trobol.
JOB 21:14 Dem dey tell God sey ‘Leave us! Wi nor won serve or follow Yu.’
JOB 21:15 Dem sey ‘Who bi dis God sef? Why wi go serve am? Any gain dey to pray to am?’
JOB 21:16 Dem tink sey na dia pawa dem take get evritin wey dem get, but I nor agri with wetin dem dey tink.
JOB 21:17 “Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get? Wiked pipol don ever face trobol? God don ever vex ponish wiked pipol?
JOB 21:18 How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey or dust wey breeze karry go?
JOB 21:19 Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’ No! But make God ponish di pesin wey sin, so dat e go know wetin e do!
JOB 21:20 Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.
JOB 21:21 Bikos wen pesin die, e nor kare about wetin happen to en family.
JOB 21:22 Anybody fit tish God, abi who dey judge doz wey dey heaven?
JOB 21:23 “Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die; dem die with happiness and dem dey for peace.
JOB 21:24 Dia body dey shine well-well and dia bones dey strong.
JOB 21:25 Odas nor get happiness at-all; dem live and die with bitterness for dia mind.
JOB 21:26 But evribody must die. Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.
JOB 21:27 “Yes! I know wetin yu dey tink. Yu dey tink how yu go take wound mi
JOB 21:28 Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
JOB 21:29 Abi yu neva tok to pipol wey travel before? Yu nor know di kind ripot wey dem dey bring kom back?
JOB 21:30 Di day wey God go vex ponish pipol, na di wiked ones E go sorry for.
JOB 21:31 E nor get who fit blame wiked pipol for all wetin dem don do.
JOB 21:32 Dem go guide di grave wey dem beri dem put afta dem don die.
JOB 21:33 Pipol go many for dia burial and di san go kold for dia body.
JOB 21:34 So how yor bad words won take konfort mi wey e bi sey evry ansa wey yu dey give mi, na lie!”
JOB 22:1 Elifaz wey kom from Teman still sey:
JOB 22:2 “E get any wise pesin wey God fit gain from?
JOB 22:3 Yu feel sey God get gain from di good tins wey yu dey do or di rite way wey yu dey follow?
JOB 22:4 God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am?
JOB 22:5 No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do.
JOB 22:6 Yu sey make yor broda pay di money wey e dey hold yu kon seize all en klot.
JOB 22:7 Pipol wey don taya to work, yu nor agri give dem wota drink and wen dem dey hongry, yu nor give dem food chop.
JOB 22:8 Yu dey opress pipol with yor pawa and pozishon.
JOB 22:9 Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die.
JOB 22:10 Naw, si as trobol surround yu and fear don dey kill yu small-small.
JOB 22:11 Yu nor dey si again, bikos di trobol don too dark for yor eye and wota don kover yu.
JOB 22:12 God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.
JOB 22:13 But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’
JOB 22:14 Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven?
JOB 22:15 Yu really won waka for di road wey wiked pipol dey pass?
JOB 22:16 Even before dia time end, wota don karry dem go.
JOB 22:17 Dis na di pipol wey rijet God, dem bilive sey E nor fit do dem anytin.
JOB 22:18 Na dis God make dem get money, yet I nor fit undastand how wiked pipol dey tink sef.
JOB 22:19 Good pipol dey happy and doz wey dia belle klean, dey laf.
JOB 22:20 Evritin wey wiked pipol get don skata and fire don burn di ones wey remain.
JOB 22:21 Job! Abeg, go setol with God. Nor dey bihave like sey God na yor enemy. If yu follow am make peace, E go bless yu.
JOB 22:22 Make yu follow di tins wey E dey tish kon keep en words for yor heart.
JOB 22:23 Make yu go back go meet God; if yu remove wiked tins for yor house, E go karry yu up.
JOB 22:24 If yu stop to porshu money kon trowey yor gold for river,
JOB 22:25 God wey dey heaven go bi yor propaty. E go bi yor gold and silva.
JOB 22:26 Den yu go bilive God kon know sey na-im dey give happiness.
JOB 22:27 Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make.
JOB 22:28 Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way.
JOB 22:29 God dey save pipol wey dey honbol, but doz wey feel sey dem wise, E dey disgrace dem.
JOB 22:30 God go save pesin wey nor dey innocent, bikos yor hand dey klean.”
JOB 23:1 Job kon ansa:
JOB 23:2 “Today, my komplain still dey make my heart betta; I nor fit hold my bitterness.
JOB 23:3 If to sey I know where I go for si God and how to go where E dey,
JOB 23:4 I for komplain gi-am kon tell am all di trobol wey I dey face.
JOB 23:5 I won know wetin E go tok and how E go ansa mi.
JOB 23:6 God go fight mi with all en pawa? No! I nor tink so. E go listin and ansa mi wen I tok.
JOB 23:7 Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok, den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever.
JOB 23:8 I don find am go east, but I nor si am. I nor si am for west wen I find am go der too.
JOB 23:9 Wen God dey work for nort and sout, I nor still si am.
JOB 23:10 Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold.
JOB 23:11 Bikos I just dey waka follow God for back; for di road wey E choose by ensef and I nor dey waka on my own.
JOB 23:12 I dey always do wetin E tok; dey follow en words; nor bi my own.
JOB 23:13 E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.
JOB 23:14 E go do wetin E don plan for mi. Na-im dey kontrol my destini.
JOB 23:15 Na dis make mi dey fear and wen ever I si am, my hold body go dey shake.
JOB 23:16 True-true, na God make mi dey fear. E don distroy di mind wey I get.
JOB 23:17 Na God, nor bi di darkness make mi kwayet, even doh di darkness don kover my face.
JOB 24:1 “Why God nor set di time wen E go take judge pipol; di day wey E go judge di pipol wey dey woship am?
JOB 24:2 Stone wey dem take mark land, pipol dey move am komot from where dem put am, so dat dem go get many land; dem still dey tif animals join dia own.
JOB 24:3 Shidren wey nor get papa and mama again, dem dey take dia donkey and bikos of di money wey wimen wey nor get husband dey hold, pipol dey seize dia animals.
JOB 24:4 Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.
JOB 24:5 Just like wiked donkey for desert, na so poor pipol dey find food waka. Dem even dey find food rish desert so dat dia shidren go chop.
JOB 24:6 Dem just dey work for land wey nor bi dia own and dem dey chop from wiked pipol land.
JOB 24:7 For nite, dem dey sleep without kover klot; nor-tin dey to keep dem from kold.
JOB 24:8 Rain wey dey fall on-top di mountin dey beat dem and dem dey go hide under rock, bikos dem nor get house.
JOB 24:9 Wiked pipol dey use small pikin wey nor get papa take do slave kon seize poor pipol shidren, bikos of di money wey dem dey hold.
JOB 24:10 But poor pipol dey naked go out; na with honga dem take dey work.
JOB 24:11 Dem go press oil kom out from olive fruit and wine from grape fruit, but demsef nor go even si wota drink.
JOB 24:12 For inside town, doz wey wound and di ones wey dey die, dey kry, but God nor dey ansa dem.
JOB 24:13 E get pipol wey rijet di lite; dem nor undastand di lite or follow where e dey lead dem go.
JOB 24:14 For day break, wiked pipol go get up go kill poor pipol and for nite, dem go-go tif dia propaty.
JOB 24:15 Di ones wey don marry wey dey sleep with oda pipol, go kover dia face make nobody si dem.
JOB 24:16 For nite, tif go break enter pipol house, but for day time, di tif go-go hide from lite.
JOB 24:17 Dem dey fear morning lite, but dem nor get anytin to fear for nite.
JOB 24:18 But na wota go karry wiked pipol go; God go curse dia land and nobody go work for dia farm again.
JOB 24:19 As snow dey dry for heat and melt for sun, na so sinnas go vanish from dis land.
JOB 24:20 Even dia mama nor go remember dem again. Na worm go chop dem and dem go bi like tree wey dem kut trowey.
JOB 24:21 Dem dey ponish wimen wey dia husband don die and doz wey nor get pikin.
JOB 24:22 But God go distroy wiked pipol with en pawa; wen God take akshon, wiked pipol nor get hope again.
JOB 24:23 God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.
JOB 24:24 Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
JOB 24:25 If nor bi so e bi, who go fit sey I dey lie or sey wetin I tok, nor bi true?”
JOB 25:1 Bildad kon sey:
JOB 25:2 “Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace.
JOB 25:3 Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish?
JOB 25:4 Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?
JOB 25:5 For God eye, even di moon nor brite and di stars nor shine rish.
JOB 25:6 Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?”
JOB 26:1 Job ansa:
JOB 26:2 “Si how yu don help pipol wey nor get pawa. Yu don save pipol wey nor get strent at-all!
JOB 26:3 Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools, like mi!
JOB 26:4 Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok? Na wish spirit make yu dey tok like dis?
JOB 26:5 “Dead body dey shake with fear for dia grave. Evritin wey dey inside wota dey shake too.
JOB 26:6 Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
JOB 26:7 God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.
JOB 26:8 Na God put wota for di kloud and E nor dey let rain fall from di kloud with force.
JOB 26:9 Na-im use di kloud take kover di moon.
JOB 26:10 E kreate di sky wen E separate di wota and divide lite from darkness.
JOB 26:11 As God tok, di pila wey hold di sky kon dey shake with fear.
JOB 26:12 Na en pawa E use take silent di sea. Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju.
JOB 26:13 Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.
JOB 26:14 But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”
JOB 27:1 Job still sey:
JOB 27:2 “As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,
JOB 27:3 as far I dey breath and God still give mi life,
JOB 27:4 my mout nor go ever tok bad and my tongue nor go ever tok lie-lie words.
JOB 27:5 I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.
JOB 27:6 I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.
JOB 27:7 “Make all my enemies, sofa like wiked pipol and doz wey nor know God.
JOB 27:8 Doz wey nor know God before dem die, na wish kind hope dem get?
JOB 27:9 Wen trobol go kom, God go hear dia kry?
JOB 27:10 God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?
JOB 27:11 Make I tish yu how God pawa strong rish. Make I tell yu about di Almighty God plan.
JOB 27:12 But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”
JOB 27:13 Zofar ansa, “Na so God take dey ponish pipol wey dey like trobol and do wiked tins.
JOB 27:14 If dia shidren many, dem go die for war and di ones wey remain nor go si food chop beleful.
JOB 27:15 Di ones wey manage survive, na sickness go still kill dem and dia wife nor go kry for dem.
JOB 27:16 Wiked pipol fit get plenty money like san, dia klot fit plenty pass evribody own,
JOB 27:17 but na good pipol go wear dia klot kon kollect dia money.
JOB 27:18 Wiked pipol dey build house like spider own or like where hunta dey stay.
JOB 27:19 E go sleep as rish man, but wen e wake-up, e nor go si en money again.
JOB 27:20 Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go and for nite, breeze go blow dem trowey.
JOB 27:21 Strong wind from east go swip dem komot from dia house
JOB 27:22 and as dem dey try to run, God nor go sorry for dem and E go blow dem fall.
JOB 27:23 Strong breeze go push dem as dem dey run and with en pawa, e go porshu dem komot from where dem dey.”
JOB 28:1 Job sey, “Where dem for dey dig silva, na der precious stones dey and e still get where dem for dey rifine gold too.
JOB 28:2 Na from groun dem for dey dig iron and melt koppa.
JOB 28:3 Man don end darkness, bikos dem shine lite dey search under di eart and dey dig rock wey dey for darkness.
JOB 28:4 Where dem for dig di precious stones dey far from where pipol dey stay and nobody dey travel pass der again. Dem dey stagga fall and pipol nor dey der.
JOB 28:5 Even doh food dey kom from di eart, evriwhere under di eart, don skata like wetin fire burn.
JOB 28:6 Na betta stone dey di eart and gold dey en dust.
JOB 28:7 No bird know di road wey lead to where gold dey and know vulture don fly pass or si am before.
JOB 28:8 No lion or oda wiked animals fit travel pass dat road wons.
JOB 28:9 Pipol dig di rock and mountins wey hard pass bikos dem dey find gold.
JOB 28:10 As dem dey dig hold for di rock, dem kom si precious stones.
JOB 28:11 Dem dig rish wota kon bring wetin dem hide, kom out for lite.
JOB 28:12 “But where wi go fit si wisdom? Where wi go fit learn how to undastand?
JOB 28:13 Yu nor fit si wisdom with human being; bikos e nor dey among pipol wey dey alive.
JOB 28:14 Even bottom river sey, ‘E nor dey with mi’ and under sea sey, ‘E nor dey with mi too.’
JOB 28:15 Dem nor go fit buy wisdom with gold or silva.
JOB 28:16 Di gold and jewel wey fine pass nor get value rish wisdom.
JOB 28:17 Wisdom dey more important pass gold; e even dear pass where gold full or where fine glass dey.
JOB 28:18 Wisdom get betta value pass diamond or fine glass.
JOB 28:19 Topaz stone wey fine pass and di gold wey klean pass, dem nor fit kompare dem with wisdom.
JOB 28:20 “But where wisdom from kom sef? Where wi go for fit learn how to undastand?
JOB 28:21 Nor-tin wey dey live for dis life fit si wisdom, even di birds wey dey fly nor fit si am.
JOB 28:22 Deat and distroshon agri sey, na hear dem just dey hear.
JOB 28:23 Na only God know di way and place where dem fit si wisdom,
JOB 28:24 bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
JOB 28:25 Na God give breeze pawa kon measure where di sea go rish.
JOB 28:26 Na God dey choose where di rain go fall rish and where tonda go travel pass.
JOB 28:27 Na der E si wisdom kon test as e important rish, den E si sey e dey good.
JOB 28:28 God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
JOB 29:1 Job still sey:
JOB 29:2 “If to sey my life go fit bi as e bi before wen God dey look and guide mi!
JOB 29:3 Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
JOB 29:4 Dat na di time wey evritin still dey well with mi. Den God goodness still dey protet my house.
JOB 29:5 Den God still dey with mi and all my shidren gada round mi.
JOB 29:6 My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
JOB 29:7 Wen ever di town eldas dey meet and I go der,
JOB 29:8 yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom and old pipol dey stand greet mi with respet.
JOB 29:9 Di leaders wey dey lead di pipol go stop to tok.
JOB 29:10 Even di pesin wey dey important pass, go shut up for mi.
JOB 29:11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi. Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi.
JOB 29:12 Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go.
JOB 29:13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die.
JOB 29:14 I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good.
JOB 29:15 Na mi bi blind pipol eye and doz wey nor fit waka, na mi bi dia leg.
JOB 29:16 I bi like papa to poor pipol and I dey setol matter even for doz wey I nor know.
JOB 29:17 I dey distroy wiked pipol pawa kon release di pesin wey dem katch.
JOB 29:18 “Den I sey, I go get long life kon die for my house without trobol.
JOB 29:19 I go bi like tree wey en rut get wota; wey dew dey wet en branches.
JOB 29:20 Evribody go dey praiz mi and my pawa nor go fail.
JOB 29:21 “Wen I dey advise pipol, dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
JOB 29:22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish. My word dey enter dia mind well.
JOB 29:23 Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall.
JOB 29:24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again and my betta face dey give dem hope.
JOB 29:25 I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol.
JOB 30:1 “But pipol wey yong pass mi dey laf mi naw! Pipol wey dia papa nor dey yuzful, wey I nor go even allow join di dogs wey dey guide my sheep.
JOB 30:2 Dem bi yuzles pipol and dem too weak to do any work for mi.
JOB 30:3 Bikos dem poor well-well and honga won kill dem, dem kon dey chop dry rut and dirty for nite.
JOB 30:4 Dem dey pul and chop plant for desert; even di small tree wey en rut nor get taste, dem dey chop am too!
JOB 30:5 Evribody dey shaut follow dem like tif kon porshu dem komot from di land.
JOB 30:6 Dem dey stay for inside hold wey en wota don dry and inside rock too.
JOB 30:7 Dem dey bihave and shaut like animals and gada togeda for bush.
JOB 30:8 Dem nor get sense or name and dem porshu dem komot di town.
JOB 30:9 “Naw, dem dey kom laf and take mi sing. Na mi dem dey take do joke naw.
JOB 30:10 Dem dey trit mi like sey I dey smell; dem feel sey dem too good pass mi, so dem kon spit for my face.
JOB 30:11 Bikos God don make mi weak and I nor get who go help mi; dem kon use all dia vexnashon take face mi.
JOB 30:12 Dem gada kon fight mi; dem drive mi from one place to anoda and dem don agri for wetin dem go do mi.
JOB 30:13 Dem follow mi as I dey run kon dey try to distroy mi and e nor get who fit stop dem.
JOB 30:14 Dem kon attack mi from difren angle. Dem jump press mi wen I don already fall.
JOB 30:15 Fear don chop my full body; my respet don go like wota proof wey breeze blow and my glory don vanish like kloud.
JOB 30:16 “I won die naw; bikos na so-so pains full my days.
JOB 30:17 Di nite dey make my bones pain mi; di pains dey bite mi and e nor gri stop.
JOB 30:18 God hold mi for neck with pawa kon make di klot wey I wear, dirty.
JOB 30:19 E trow mi for mud and naw, I bi like dust and ashes.
JOB 30:20 God, I dey koll Yu, but Yu nor gri ansa and wen I pray, Yu nor gri listin to my prayers.
JOB 30:21 Yu dey do mi anyhow; Yu dey ponish mi with all yor pawa.
JOB 30:22 Yu allow breeze blow mi go; Yu trow mi up-and-down for inside strong breeze.
JOB 30:23 I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; di place wey Yu keep for evribody.
JOB 30:24 “True-true, nobody go fight poor pesin, wen e kry sey make dem help am from en trobol.
JOB 30:25 Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry kon sorry for pipol wey nor get at-all?
JOB 30:26 Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.
JOB 30:27 Pain and worry don skata my body; I dey sofa evriday.
JOB 30:28 I just dey waka for darkness and I nor dey si lite at-all. I dey beg for help for where crowd Gad put.
JOB 30:29 I don kry sotey my vois don krack and my neck don long like Ostrich own.
JOB 30:30 My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
JOB 30:31 I nor fit remember di last time wen I hear betta music, bikos na only song wey go make mi mourn and kry, naim dem dey play.
JOB 31:1 “I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.
JOB 31:2 Wetin God for heaven choose for us? Wetin wi go gain from di Almighty wey dey heaven?
JOB 31:3 Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins and wahala for wiked pipol?
JOB 31:4 God know evritin wey I dey do; E dey si evry step wey I dey take.
JOB 31:5 I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.
JOB 31:6 Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.
JOB 31:7 If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,
JOB 31:8 den make anoda pesin chop wetin I plant. Make dem rut and distroy evritin wey I plant.
JOB 31:9 If I dey like and won sleep with woman for my heart kon dey wait and hide outside en door,
JOB 31:10 den make my wife kook for anoda man chop and make e sleep for anoda man bed.
JOB 31:11 Bikos dat go bi big shame and na deat dem take dey ponish dat kind wikedness.
JOB 31:12 Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins; fire wey go burn evritin wey I get.
JOB 31:13 If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.
JOB 31:14 If I nor dey do dem well, how I won take face God? Wetin I won tok if God kom judge mi?
JOB 31:15 Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.
JOB 31:16 I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain
JOB 31:17 or allow shidren wey nor get papa and mama dey hongry, while I dey chop.
JOB 31:18 Na since wen I small I don dey kare for doz wey nor get papa and mama and till I die, I go always dey kare for wimen wey dia husband don die.
JOB 31:19 If I si pesin wey nor get at-all; wey won die, bikos e nor get wetin to wear,
JOB 31:20 I go gi-am klot wey dem use my own animal wool take make. Den e go tank mi with en hold heart.
JOB 31:21 If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,
JOB 31:22 den make my hand break. Make e break komot from my shoulder.
JOB 31:23 But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.
JOB 31:24 I neva ever bilive money. I nor ever si am as wetin go protet mi
JOB 31:25 or kom dey karry body, bikos of di money wey I get.
JOB 31:26 I neva ever woship sun, bikos e dey give lite or di moon, bikos e fine.
JOB 31:27 I neva for one day like dem rish wen I go kon dey kiss my hand dey woship dem.
JOB 31:28 Na deat dem take dey reward dat kind sin; bikos e go mean sey I nor honor God name.
JOB 31:29 I neva happy wons, bikos my enemies dey sofa; or dey for peace, bikos dem dey face trobol.
JOB 31:30 I neva ever pray make dem die, bikos if I do like dat, God nor go forgive mi.
JOB 31:31 My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’
JOB 31:32 Doz wey dey travel, I dey koll dem enter my house and I nor dey let dem travel or sleep for road wen nite rish.
JOB 31:33 Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.
JOB 31:34 I nor dey kwayet or stay for inside house, bikos I dey fear sey pipol go curse or tok against mi.
JOB 31:35 “Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.
JOB 31:36 I go karry dem without shame for my shoulder kon wear dem like king crown.
JOB 31:37 I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.
JOB 31:38 “If I tif di land wey I for dey farm or take am from di original owner,
JOB 31:39 or chop di food wey grow for der, so dat di owner nor go si chop,
JOB 31:40 den instead of fruit or korn to grow, make bush and grass grow full dat land!” Den Job kon stop to dey tok.
JOB 32:1 So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.
JOB 32:2 Den Elihu wey bi Barakel pikin from Ram family for Buz kon dey vex. E dey vex, bikos Job sey e nor do God anytin.
JOB 32:3 E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong.
JOB 32:4 Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish.
JOB 32:5 Wen e si sey di three men nor fit ansa Job again, e kon dey vex.
JOB 32:6 Elihu wey en papa na Barakel wey kom from Buz kon sey: “I know sey I small and yu don old and na dis make mi dey fear to tell yu wetin I dey tink.
JOB 32:7 I tell mysef sey make una tok, bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
JOB 32:8 But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.
JOB 32:9 Nor bi old age go make pesin wise or tish pipol how to undastand wetin dey rite.
JOB 32:10 Naw, I won tok and una go listin to mi. Make I tell una wetin I know.
JOB 32:11 I kwayet dey listin to wetin una dey tok since; I dey listin to una wise word and as una dey tink wetin to tok.
JOB 32:12 I hear una well-well, but una nor fit show sey Job dey wrong; nobody among una fit ansa en kweshon.
JOB 32:13 So why una dey tell pipol sey una get wisdom? Naw, na only God go fit ansa am, bikos una don fail.
JOB 32:14 Job dey tok to una; nor bi mi e dey tok to, but if na mi e tok to, I nor go ansa am di way wey una take ansa am.
JOB 32:15 “Job, yor words too strong for all of dem; dem nor get ansa for yu.
JOB 32:16 Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok? Dem just stand for der, bikos dem nor get anytin to tok again.
JOB 32:17 But I go give yu my own ansa and I go tell yu wetin I dey tink.
JOB 32:18 I nor fit wait to tok or hold my words again.
JOB 32:19 If una nor let mi tok, my belle go burst like wine wey dey new wine bag.
JOB 32:20 I must tok make I dey free! I nor fit bear-am again!
JOB 32:21 I nor go support one pesin for dis matter and I nor go praiz anybody sef!
JOB 32:22 I nor sabi praiz pesin anyhow, bikos God go ponish mi, if I do like dat.
JOB 33:1 “Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok!
JOB 33:2 Si naw, I don open my mout and my tongue won start to tok.
JOB 33:3 All my words na true and na true I go tok.
JOB 33:4 Na God Spirit make mi and na en breath give mi life.
JOB 33:5 Make yu ansa mi if yu fit. Make yu dey ready and prepare yor kweshons.
JOB 33:6 Na di same tin mi and yu bi for God eye, na san dem take make mi and yu.
JOB 33:7 So yu nor get rizin to fear mi and I nor go wahala yu too mush.
JOB 33:8 “Naw, dis na wetin I hear wen yu dey tok:
JOB 33:9 ‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.
JOB 33:10 But God dey find rizin make E for dey ponish mi like sey I bi en enemy.
JOB 33:11 E tie my leg with shain; E dey si evriwhere wey I waka go.’
JOB 33:12 But I won tell yu sey yu dey wrong, bikos God big pass evribody.
JOB 33:13 Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?
JOB 33:14 “Even as God dey tok evritime, nobody won wait listin to wetin E dey tok.
JOB 33:15 For nite wey pipol dey sleep, God dey tok to dem for vishon or thru dreams.
JOB 33:16 Wen E make dem listin to wetin E dey tok, dem go dey fear for di warnin wey E dey give dem.
JOB 33:17 God dey tok so dat dem go stop to sin kon honbol demsef, make E for fit save dem.
JOB 33:18 E nor go let dem distroy demsef; E go save dem from deat.
JOB 33:19 God dey send sickness to take korrect some pipol and dem go take korreshon wen dia body dey feel di pain.
JOB 33:20 Pipol wey dey sick nor fit even chop di food wey sweet well-well.
JOB 33:21 Dia body dey die go and yu nor go fit si dia bones again.
JOB 33:22 Dem go soon go join dead body. Deat angel dey wait for dem.
JOB 33:23 May bi one angel go help am; one out of di tazon angels wey God get wey go tell am wetin dey rite.
JOB 33:24 Bikos God don forgi-am, di angel go sey, ‘Release am! E nor go fit go join dead body. Si wetin dem take replace en sin, so e don dey free.’
JOB 33:25 En body go kom yong and strong again like small pikin own.
JOB 33:26 Den wen e pray, God go ansa am. E go woship God with happiness. God go make am dey raitious for en eye again.
JOB 33:27 Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’
JOB 33:28 E don save mi from deat and I still dey alive.
JOB 33:29 “True-true, God dey always do like dis, many-many times with pipol.
JOB 33:30 E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again.
JOB 33:31 So Job, make yu listin to wetin I dey tok. Naw, kwayet make yu let mi tok.
JOB 33:32 But if yu get wetin yu won tok, tok and I go tell yu if yu dey rite.
JOB 33:33 But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.”
JOB 34:1 Elihu still sey:
JOB 34:2 “Wise men, make una listin to my words; Make una hear mi, men wey know well-well.
JOB 34:3 Una know betta food wen una put am for mout, but una ear nor know wise word wen e hear am.
JOB 34:4 So make wi choose wetin dey rite. Make wi know among awasef wetin dey good.
JOB 34:5 Job sey en know do bad tin and God nor gri defend am.
JOB 34:6 E sey, ‘As I dey rite so, make I lie sey I dey wrong? Dem nor fit heal my wound, even doh I nor sin at-all.’
JOB 34:7 Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?
JOB 34:8 E like make bad pipol dey stay with am and e dey waka with sinnas.
JOB 34:9 E sey pesin nor dey gain anytin, if e dey obey God.
JOB 34:10 “Men wey dey undastand, make una listin to mi! God Almighty go fit do wetin dey wrong?
JOB 34:11 E dey reward pipol for wetin dem do and dey trit dem as dem deserve.
JOB 34:12 True-true, God nor dey do bad tin; E dey judge evribody as e suppose bi.
JOB 34:13 Abi God get en pawa for anoda place? Na somebody tell am sey make E kare for di world?
JOB 34:14 If God remove di breath wey dey give us life,
JOB 34:15 den evribody wey dey live for dis life go die kon turn to san.
JOB 34:16 “Naw, make yu listin to mi. If yu get undastandin, make yu hear mi.
JOB 34:17 So yu dey tok sey God nor dey rite naw? Yu feel sey E hate justice?
JOB 34:18 God dey kondemn kings and rulers wey wiked and nor dey yuzful.
JOB 34:19 E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.
JOB 34:20 Pesin fit die for nite just like dat, but God nor dey struggol to distroy pipol wey tink sey dem get pawa.
JOB 34:21 God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take.
JOB 34:22 E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.
JOB 34:23 Wi nor fit set di time wey God go take judge all of us.
JOB 34:24 E nor nid pesin to tell am anytin, before E go remove leader kon put anoda pesin for en post.
JOB 34:25 Bikos E know wetin di leader do. E fit ova-trow and skata dem for nite.
JOB 34:26 E dey ponish sinnas bikos of dia sin and na for where evribody go for si dem,
JOB 34:27 bikos dem don stop to follow en laws and kommand.
JOB 34:28 Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.
JOB 34:29 If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.
JOB 34:30 God dey do like dis, so dat wiked pipol nor go rule and opress di pipol.
JOB 34:31 “Wetin make pipol nor dey konfess dia sins give God kon promise sey dem nor go sin again;
JOB 34:32 den tell mi my fault so dat I nor go do dem again?
JOB 34:33 Job! Na yor choice, nor bi mi go tell God wetin yu wont, bikos yu don rijet all dis tin. Naw, make yu tell us wetin yu dey tink.
JOB 34:34 True-true, anybody wey get sense go gri and if wise man hear mi, e go tok sey,
JOB 34:35 Job just dey tok, bikos e nor know wetin e dey tok and all wetin e dey tok, nor make sense.
JOB 34:36 But I wish sey dem test Job rish di end, bikos e dey ansa like wiked pesin.
JOB 34:37 E don add trobol join e sins, bikos for awa front, e dey klap en hand and dey akuiz God.”
JOB 35:1 Elihu still sey:
JOB 35:2 “Job, e dey rite make yu dey sey yu nor do any bad tin for God eye?
JOB 35:3 Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’
JOB 35:4 I go ansa yu and all yor friends.
JOB 35:5 Make una si how di kloud high rish! Make una look di sky well-well!
JOB 35:6 If yu sin, e nor give God any trobol. Even if yu kontinue to dey sin, e nor go shake am.
JOB 35:7 Even if yu dey good well-well, na God yu dey favor? E nor get wetin God wont for yor hand.
JOB 35:8 Just as yor wikedness dey affect only pipol wey dey do like yu, na so too di good wey yu do, go affect doz wey dey do good.
JOB 35:9 Bikos of di opreshon wey pipol dey sofa from strong pipol, dem dey kry for help.
JOB 35:10 But dem nor dey kry to God wey kreate dem; wey dey give dem hope for darkness.
JOB 35:11 Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds.
JOB 35:12 Dem dey kry for help, but God nor dey ansa dem, bikos dem too proud and dem dey do bad tins.
JOB 35:13 E nor get nid for dem to kry; bikos God nor dey si or hear dia kry.
JOB 35:14 Yu sey yu nor fit si God; but make yu dey patient, bikos yor matter dey en hand.
JOB 35:15 Yu sey, ‘Wen God vex, E nor dey ponish pipol, bikos E nor dey kare about di bad tins wey dem dey do.’
JOB 35:16 But Job! No nid for yu to dey tok, bikos e klear sey yu nor know wetin yu dey tok about.”
JOB 36:1 Elihu still sey:
JOB 36:2 “Make yu relax and listin to mi small, bikos I still get some tins to tok for God, as E nor dey here with us.
JOB 36:3 I go use wetin I know take show sey God dey rite. I go tok di ones wey I know.
JOB 36:4 My words nor bi lie; na betta wise man stand for yor front so.
JOB 36:5 True-true, God strong well-well! E nor dey feel sey pesin nor dey yuzful and e nor get anytin wey E nor undastand.
JOB 36:6 E nor dey give wiked pipol long life, but E dey judge well for poor pipol.
JOB 36:7 E dey protet good pipol; E dey let dem live like kings and pipol dey respet dem forever.
JOB 36:8 But if dem shain dem inside prison and dem dey sofa, bikos of wetin dem do,
JOB 36:9 God go show dem di rizin. E go show dem dia sin and pride.
JOB 36:10 E go make dem listin to en warnin, so dat dem go leave wiked tins.
JOB 36:11 If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper.
JOB 36:12 But if dem nor gri listin to God word, dem go die and dem nor know anytin before dem go where dead body dey.
JOB 36:13 Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem.
JOB 36:14 Dem dey die wen dem still yong and na disgrace dey end dia life.
JOB 36:15 But God use sofa take dey tish and save en pipol kon korrect dem with pain.
JOB 36:16 God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.
JOB 36:17 But naw, yu dey get di kind ponishment wey fit yu.
JOB 36:18 Make yu dey kareful, so dat dem nor go fool yu with money or sey yu follow money go di wrong way.
JOB 36:19 E nor go do yu any good sey yu dey kry for help; bikos yu get betta pawa wey nor fit help yu.
JOB 36:20 Nor dey wait for nite, wen pipol don go dia house.
JOB 36:21 Make yu dey kareful, so dat yu nor go do bad tin, bikos yu dey sofa.
JOB 36:22 Make yu remember how God strong rish, bikos na-im dey tish tishas.
JOB 36:23 Nobody fit kommand God or akuiz am sey E do bad tin.
JOB 36:24 Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am.
JOB 36:25 Evribody don si wetin E do! Na from far wi dey look am.
JOB 36:26 “Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.
JOB 36:27 Na God dey take wota from di eart kon turn am to rain.
JOB 36:28 E dey let di rain fall from di kloud, so dat pipol go prosper as dem dey work.
JOB 36:29 Nobody know how tonda take dey make nois for di sky or how kloud take dey waka for heaven where God dey.
JOB 36:30 E dey send lite pass di sky, but under di sea dey-dey dark.
JOB 36:31 Dis na how E dey feed and provide plenty food for pipol to chop.
JOB 36:32 Na en hand E take dey stop tonda lite kon send am go where E wont.
JOB 36:33 Even animals know sey tonda kom before heavy rain dey fall.
JOB 37:1 “My heart kom dey beat fast-fast as I bigin tink of dis tins.
JOB 37:2 Make all of una listin to God vois. Make una listin to di tonda wey dey kom out from en mout.
JOB 37:3 Na-im send lite go cross di sky; from one end go rish di oda end for di world.
JOB 37:4 Dat time, una go hear di vois well-well kon si di brite tonda lite as e dey pass.
JOB 37:5 Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.
JOB 37:6 Na-im dey kommand snow and heavy rain sey, make dem dey fall for di eart.
JOB 37:7 Na only en fit stop di work wey wi dey do, so dat wi go know how E strong rish.
JOB 37:8 Den animals go-go dia house kon stay der.
JOB 37:9 Heavy rain dey kom from sout, while strong kold breeze dey kom from nort.
JOB 37:10 Wen God breath, wota dey turn to block! Di wota dey block finish!
JOB 37:11 E load di kloud with wota and lite dey flash kom out
JOB 37:12 as di kloud dey go where God sey make e go. Di kloud dey do evritin wey God kommand for dis world.
JOB 37:13 God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.
JOB 37:14 Job, make yu wait small kon listin; konsida all di wonderful tins wey God don do,
JOB 37:15 den yu go know how God take dey give kommand and how E take make di lite flash for di kloud.
JOB 37:16 Yu know how di kloud take hang for sky? Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.
JOB 37:17 Wen yu dey sweet well-well bikos of di heat wey di sout wind dey bring,
JOB 37:18 yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?
JOB 37:19 Make yu tish us wetin wi go tell God, bikos wi nor get anytin for mind to tok.
JOB 37:20 Make dem go tell God sey I won tok to am? Pesin even fit tok wen e konfuse?
JOB 37:21 Naw, di lite for sky brite well-well and wi nor fit look am, bikos breeze don swip di eart klean.
JOB 37:22 Na golden lite wi dey si for di nort and na glory kover us for God present.
JOB 37:23 Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.
JOB 37:24 No wonder evribody dey fear am and E nor get anytin to do with pipol wey feel sey dem wise.”
JOB 38:1 God kon ansa Job from inside di storm:
JOB 38:2 “Who yu bi to kweshon my wisdom with yor empty words?
JOB 38:3 Naw, make yu stand like man kon ansa di kweshons wey I go ask yu.
JOB 38:4 “Yu dey der wen I kreate di heavens and eart? If yu know well-well, tell mi about dem.
JOB 38:5 Na who tok how dem go big rish? Who measure dem with tape? Yu know di ansa?
JOB 38:6 Na wetin hold di pilas wey dey support di eart? Na who put di korner-stone for di world,
JOB 38:7 wen doz wey dey stay heaven dey shaut for joy and for morning, di stars dey sing togeda?
JOB 38:8 Who klose di sea mout wen e won komot from di eart belle?
JOB 38:9 Na mi kover di sea with kloud kon gada di darkness.
JOB 38:10 I give di sea where e go flow rish kon put big gate for en back.
JOB 38:11 I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der! Na here yor pawaful wave go for stop.’
JOB 38:12 For yor life, yu don ever kommand morning or tell di day wen e go break?
JOB 38:13 Abi yu don kommand day make e seize di eart kon shake wiked pipol komot from where dem hide put?
JOB 38:14 Na day lite make di hill and valley stand like klot wey dem fold and evritin klear like wetin dem rite for groun.
JOB 38:15 Day lite too brite for wiked pipol and e dey stop dem to make trobol.
JOB 38:16 Yu don rish where di wota wey dey full di sea dey? Abi yu don waka for under sea before?
JOB 38:17 Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?
JOB 38:18 Yu know how di world big rish? Ansa mi, if yu know!
JOB 38:19 Yu know where di lite from dey kom or wetin dey bring darkness out?
JOB 38:20 Yu fit show dem how far dem fit go or send dem go house?
JOB 38:21 I dey sure well-well sey yu fit, bikos yu don old, wise well-well and dey der wen I kreate di world!
JOB 38:22 Yu don ever go where I dey keep di snow and di ice-blok rain, put?
JOB 38:23 I keep dem dey wait di time wen trobol go kom and di day wen war go start.
JOB 38:24 Yu don rish di place where sun from dey kom or di place wey east wind for dey blow kom?
JOB 38:25 Who dig pit for di rain wey dey fall kon klear road for tonda nois?
JOB 38:26 Who make di rain dey fall for where nobody dey stay?
JOB 38:27 Who dey wet di dry land with wota, so dat di grass go grow?
JOB 38:28 Abi di rain or dew get papa?
JOB 38:29 Ice-blok and kold wey dey fall kom from di sky, na who bi dia mama?
JOB 38:30 Wish time wota take strong like stone; wen sea bigin dey turn ice-blok?
JOB 38:31 Yu fit luz di klot wey dey Orion waist or yu won shain Pleiades?
JOB 38:32 Yu fit guide di stars from one sizin to anoda kon lead di big and small Bear?
JOB 38:33 Yu know di law wey dey tell di sky wetin to do? Or wetin dey make di laws work for dis eart?
JOB 38:34 Yu fit kommand di kloud kon sey make rain bigin fall?
JOB 38:35 If yu kommand lite make e flash, e go ansa yu sey, ‘I go do evritin wey yu tok?’
JOB 38:36 Na who put wisdom for pesin heart or make us dey undastand tins?
JOB 38:37 Who fit kount di kloud, bikos e feel sey e wise kon tell dem sey make rain fall;
JOB 38:38 rain wey dey make strong and dry groun soft?
JOB 38:39 Na yu dey give lion food make dem chop, or dey make small lion beleful
JOB 38:40 wen dem hide for dia hold or just sleep dey wait for dia house?
JOB 38:41 Na who dey feed raven bird wen dem dey waka dey find food for evriwhere? Even wen dia small shidren dey kry give mi sey dem dey hongry, na yu dey feed dem?
JOB 39:1 Yu know how dem take born di goats wey dey stay mountin? Yu don si wen bush animals dey born before?
JOB 39:2 Yu know how long dem dey karry dia shidren for belle? Yu know di time wey dem take dey born?
JOB 39:3 Yu know how dem take bend down for groun born dia pikin?
JOB 39:4 For inside forest dia pikin dey grow dey strong and wen dem waka go dia own, dem nor dey kom back again.
JOB 39:5 Donkey wey dey forest, na who give dem freedom? Who release and let dem dey waka up-and-down?
JOB 39:6 Na mi give dem di desert make dem stay. I sey make dem stay di empty land.
JOB 39:7 Dem nor dey stay near di town at-all, dem dey far and nobody fit go katch dem kom work.
JOB 39:8 Na for mountin dem for dey si food chop, na der dem for dey si green leaf chop.
JOB 39:9 How bush melu won take work for yu? E go gri stay one nite for yor yard?
JOB 39:10 Yu fit use rope tie bush melu make e for follow yu klear di field?
JOB 39:11 Yu sure sey e go gri use en pawa take do yor heavy work?
JOB 39:12 Yu dey espect am to bring wetin e harvest kon gada am for di place where korn dey?
JOB 39:13 Si as ostrich wey get long leg dey run, but e nor fit fly like stork.
JOB 39:14 E dey leave en egg for groun make heat for warm dem.
JOB 39:15 E nor dey kare sey pesin leg fit mash di egg or wiked animal fit kom break dem.
JOB 39:16 E dey bihave like sey nor bi en get di egg and e nor koncern am if di egg break or skata.
JOB 39:17 Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
JOB 39:18 But wen e don start to run, e dey laf horse and di pesin wey dey ride am.
JOB 39:19 So Job, na yu make horse strong like dat or na yu give dem hair like klot for dia neck?
JOB 39:20 Na yu dey make dem jump like lokust kon make pipol fear wen dem breath?
JOB 39:21 Dem dey skata groun as dem dey run for valley; dem dey rush enter war with all dia pawa.
JOB 39:22 Dem nor know wetin fear mean and know swod fit make dem turn back.
JOB 39:23 Di swod wey who dey ride dem karry, dey make nois and shine for di sun.
JOB 39:24 Horse dey run go, bikos dem just dey happy anyhow; even wen dem don blow di trumpet, dem nor go gri stop.
JOB 39:25 As dem hear di trumpet dem go vex; dem fit smell war even before dem near der and dem dey hear dia oga kommand.
JOB 39:26 Hawk dey kom ask yu make yu tish am wisdom, so dat e go know how to fly wen e spread en feada face sout?
JOB 39:27 Abi eagle go wait for yor kommand before e go build en nest for mountin?
JOB 39:28 E build en house for di rock wey high pass kon use rock take do pillow for nite.
JOB 39:29 From dat place, e dey find sometin wey e go chop, even if e dey near or far.
JOB 39:30 Eagle dey gada round dead body, while small eagle dey drink dia blood.”
JOB 40:1 Den God tell Job:
JOB 40:2 “Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
JOB 40:3 Den Job ansa God:
JOB 40:4 “True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.
JOB 40:5 I don tok pass wetin I suppose tok. I nor get anytin to tok again?”
JOB 40:6 Den from inside di storm, God kon ansa Job:
JOB 40:7 Make yu stand strait kon ansa my kweshons.
JOB 40:8 Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
JOB 40:9 Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?
JOB 40:10 If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef.
JOB 40:11 Look pipol wey tink sey dem dey important, den go honbol dem, bikos yu dey vex.
JOB 40:12 Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.
JOB 40:13 Beri all of dem for groun kon tie dem for where dead body dey.
JOB 40:14 Den na mi go first praiz yu kon gri sey yu don win di fight by yorsef.
JOB 40:15 Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu,
JOB 40:16 but si as en strent bi like lion own and e pawa dey en body.
JOB 40:17 En tail stand like tall tree and di pawa wey dey e leg, strong well-well.
JOB 40:18 En bones strong like bronze and en leg bi like iron bar.
JOB 40:19 E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol! Na only God wey kreate am go fit distroy am.
JOB 40:20 Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
JOB 40:21 E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass and e go hide among di reeds for di bush.
JOB 40:22 Inside bush dey gi-am betta place to rest. Di tall tree dey gi-am shade.
JOB 40:23 E nor dey fear wota wey dey rush pass like river; en body go kold wen Jordan River flow pass en face.
JOB 40:24 Who fit blind en eyes kom katch am? Na who fit use trap katch am thru en nose and mout?
JOB 41:1 “Yu fit use fish hook take katch Leviatan or use rope take tie en tongue?
JOB 41:2 Yu fit put rope pass en nose or hook en jaw?
JOB 41:3 E go beg yu make yu let am go? Or make e beg yu make yu sorry for am?
JOB 41:4 E go gri make agriment with yu kon promise sey e go serve yu forever?
JOB 41:5 Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house; or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with?
JOB 41:6 Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment? Pipol wey dey sell pesin go gri sell am?
JOB 41:7 Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish or katch en head with hook?
JOB 41:8 Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight!
JOB 41:9 Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun.
JOB 41:10 Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front.
JOB 41:11 Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?
JOB 41:12 Make I tell yu about Leviatan leg kon tell yu how e dey big and strong well-well.
JOB 41:13 Nobody fit tear en klot wey dey outside or shuk di armour wey e wear.
JOB 41:14 Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear, kom out?
JOB 41:15 Na many shield dem take make en back kon tie dem togeda and dem strong like stone.
JOB 41:16 Dem join dem strong well-well and space nor dey wey breeze fit pass enter en body.
JOB 41:17 En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem.
JOB 41:18 Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon.
JOB 41:19 Fire and tonda lite dey kom out from en mout.
JOB 41:20 Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey kom out from en nose.
JOB 41:21 Fire dey kom out from en mout and even wen e breath, e dey bring fire.
JOB 41:22 En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear.
JOB 41:23 E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend.
JOB 41:24 En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone.
JOB 41:25 Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow.
JOB 41:26 No swod fit wound am; no spear or arrow fit enter en body.
JOB 41:27 Iron just bi like straw for en eye and bronze dey soft like wood wey don rotin.
JOB 41:28 E nor get di arrow wey won make am run, even wen dem stone am with rock, e bi like straw for en body.
JOB 41:29 Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am.
JOB 41:30 Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun.
JOB 41:31 E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot.
JOB 41:32 E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam.
JOB 41:33 E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am and I kreate am without fear.
JOB 41:34 Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.”
JOB 42:1 Den Job ansa God:
JOB 42:2 “I know sey na Yu get pawa pass! Yu fit do anytin wey Yu won do and nobody fit stop!
JOB 42:3 Yu ask mi sey why I dey kweshon yor wisdom wen I nor know anytin at-all! I dey tok tins wey I nor undastand and mirakles wey too great for mi to know.
JOB 42:4 Yu sey make I listin as Yu dey tok and make I try to ansa yor kweshons.
JOB 42:5 Before, I know only wetin pipol tell mi, but naw, I don si Yu with my own eye.
JOB 42:6 So I dey shame, bikos of all wetin I don tok and I go pak dust for my head to take show sey I dey sorry for all wetin I tok.”
JOB 42:7 Afta God don tok finish with Job, E kon tell Elifaz sey, “I dey vex with yu and yor two friends, bikos yu nor tok di trut about mi, as my savant Job do.
JOB 42:8 Naw, make una take seven ram and seven melu go give Job kon offa dem as sakrifice for unasef. Job go pray for una; den I go ansa una prayers and I nor go disgrace una again, bikos una nor tok di trut about mi just as Job tok.”
JOB 42:9 So, Elifaz, Bildad and Zofar kon do wetin God sey make dem do, den God kon ansa dia prayers.
JOB 42:10 Afta Job don pray for en friends, God kon make am rish for evry side again and E gi-am taims-tu of evritin wey e lost.
JOB 42:11 Job brodas and sistas plus en friends wey run leave am before kon visit am and dem do party for en house. Dem kom tell am sey, “Wi dey sorry for all di trobol wey God kause for yu.” So all of dem kom give Job money and gold rings.
JOB 42:12 God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.
JOB 42:13 Job kon still born seven sons and three dotas.
JOB 42:14 E koll di first girl Jemimah, di sekond girl Kezaya and di third girl Keren-Happuk.
JOB 42:15 E nor get any woman for di hold world wey fine rish Job dotas. Dia papa give dem part of wetin e get and e still give di sons too.
JOB 42:16 Job stay 140 year afta di trobol wey e face, e si en grand and great grand-shidren dem before e die.
JOB 42:17 So, Job die for betta old age.
PSA 1:1 God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
PSA 1:2 Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
PSA 1:3 E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.
PSA 1:4 But nor bi so e bi for wiked pipol! Instead, dem bi like leaf wey breeze blow trowey.
PSA 1:5 Bikos of dis, wiked pipol nor go fit stand for Judgement Day and sinnas nor go fit dey for where God pipol gada put.
PSA 1:6 True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.
PSA 2:1 Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
PSA 2:2 Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
PSA 2:3 Dem dey sey, “Make wi break di shains wey dem take shain us! Make wi free awasef from dia trap!”
PSA 2:4 But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.
PSA 2:5 So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,
PSA 2:6 “I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”
PSA 2:7 Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!
PSA 2:8 Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.
PSA 2:9 Na iron rod yu go take break dem kon skata dem like pot wey dem mold with san!’ ”
PSA 2:10 So naw, una wey bi king, make una do wetin dey rite; una wey dey rule di world, make una dey take korreshon!
PSA 2:11 Make fear dey una heart as una dey serve God! Make una turn from sin kon meet God as una dey fear am!
PSA 2:12 Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!
PSA 3:1 David Song My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi.
PSA 3:2 Many of dem dey sey, “God nor go save am.”
PSA 3:3 But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.
PSA 3:4 Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
PSA 3:5 I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.
PSA 3:6 I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.
PSA 3:7 My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
PSA 3:8 Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.
PSA 4:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
PSA 4:2 Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
PSA 4:3 Make una know sey, God dey keep doz wey dey fear am for ensef and E go ansa wen wi koll am.
PSA 4:4 So make yu fear God and nor sin. Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.
PSA 4:5 Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am.
PSA 4:6 Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.
PSA 4:7 Yu don give mi more joy pass doz wey get many food and wine to drink.
PSA 4:8 I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi.
PSA 5:1 For Di Kwayamasta: Di Song My Oga God, make Yu listin as I dey pray to Yu! Make Yu listin to my komplain.
PSA 5:2 My King and my God, make Yu listin to my kry for help, bikos na only Yu I dey pray to.
PSA 5:3 Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.
PSA 5:4 My God, Yu nor dey like bad tins; Yu nor fit bear wiked pipol sins.
PSA 5:5 So, proud pipol nor go fit stand for yor present, bikos Yu hate anybody wey dey do bad tin.
PSA 5:6 Yu go distroy doz wey dey lie well-well. God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.
PSA 5:7 Bikos of yor love wey nor dey die, I go enter yor house kon bow woship Yu for yor holy temple.
PSA 5:8 My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,
PSA 5:9 bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.
PSA 5:10 My God, make Yu disgrace dem. Make dia own trap katch dem. Make Yu drive dem, bikos of dia sins and bikos dem don turn against Yu.
PSA 5:11 But make doz wey Yu dey guide, always dey happy! Make dem always dey shaut for joy! Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!
PSA 5:12 My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu. Yu dey always protet dem well-well, bikos of yor favor wey nor dey end.
PSA 6:1 David Song My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex. Nor ponish mi with yor vexnashon.
PSA 6:2 Make Yu sorry for mi, bikos I dey weak. Make Yu heal mi, bikos my bones dey shake.
PSA 6:3 I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?
PSA 6:4 Make Yu kom back kon help mi. Save mi bikos of yor love wey nor dey fail.
PSA 6:5 Pesin wey don die, nor dey remember Yu. Na who go fit praiz Yu from inside grave?
PSA 6:6 I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.
PSA 6:7 Sofa don make my eyes blind. My eyes dey weak, bikos of my enemies.
PSA 6:8 All of una wey dey do bad tins, make una leave mi alone, bikos God don hear my kry.
PSA 6:9 God don hear as I dey beg; E go ansa my prayers.
PSA 6:10 So make disgrace follow all my enemies and make dem dey fear well-well! Make dem run turn back, go hide with shame.
PSA 7:1 David Song About Benjamin And Kush Pipol My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi. So make Yu save mi from doz wey won kill mi!
PSA 7:2 If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.
PSA 7:3 My Oga God, if I don do any wrong tin or dey guilty as dem tok;
PSA 7:4 if I sin against my friend or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi,
PSA 7:5 den make my enemies porshu and katch mi. Make dem mash mi die kon trowey my body for groun.
PSA 7:6 My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!
PSA 7:7 Pipol for di world gada round Yu, so make Yu rule dem from yor throne.
PSA 7:8 Bikos na Yu dey judge evribody, make Yu show sey I dey good, bikos true-true, I dey innocent and na Yu bi di Most High God!
PSA 7:9 Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good, bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart.
PSA 7:10 Na God bi my guide! E dey save doz wey get klean and true heart.
PSA 7:11 God dey judge well. E dey vex for wiked pipol evriday.
PSA 7:12 If pesin nor gri turn from sin kom meet God, God go sharp en swod kon ready to shot en bow.
PSA 7:13 E go ready en swod wey dey kill kon shot en arrow wey dey hot like fire.
PSA 7:14 Pesin wey karry wikedness and bad plans for belle, dey born lie-lie.
PSA 7:15 E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter
PSA 7:16 and di trobol wey e plan for odas, dey fall for en own head. Na en own wahala dey kause trobol for am.
PSA 7:17 So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.
PSA 8:1 David Song Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens.
PSA 8:2 Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.
PSA 8:3 Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
PSA 8:4 I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”
PSA 8:5 Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor.
PSA 8:6 Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol;
PSA 8:7 all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked,
PSA 8:8 di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota.
PSA 8:9 Oga awa God, yor greatness full di whole world.
PSA 9:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
PSA 9:2 I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
PSA 9:3 bikos as my enemies si Yu, dem stagga fall kon die.
PSA 9:4 Naw, yor judgement don favor mi and Yu don judge well from yor throne.
PSA 9:5 Yu make di nashons dey fear kon distroy wiked pipol, den Yu remove dia name from yor book forever.
PSA 9:6 My enemies don die finish forever; di towns wey Yu rut komot from groun, dem nor go ever remember dem again.
PSA 9:7 But God go reign forever and E go dey judge from en throne.
PSA 9:8 E go judge di world well kon rule di pipol with betta mind.
PSA 9:9 Na God dey guide doz wey dem dey opress; na-im dey save dem wen trobol kom.
PSA 9:10 Doz wey dey loyal to Yu, dey trust Yu, bikos Yu nor dey leave doz wey wont make Yu help dem.
PSA 9:11 E good make wi sing praiz to God wey dey rule from Jerusalem. Make wi tell di world all di tins wey E do, wey dem nor fit forget.
PSA 9:12 Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.
PSA 9:13 My Oga God, make Yu sorry for mi. Si as my enemies dey trobol mi, so make Yu kom take mi komot from deat mout.
PSA 9:14 Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
PSA 9:15 Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.
PSA 9:16 Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.
PSA 9:17 Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.
PSA 9:18 But God nor go forget doz wey dey kry for help. E nor go live dem forever; E go always dey give poor pipol hope.
PSA 9:19 My Oga God, make Yu raiz-up! Nor let wiked pipol win! Make Yu kom judge di nashons.
PSA 9:20 Make dem fall with fear. Make Yu let pipol know sey, na ordinary human being dem bi.
PSA 10:1 My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
PSA 10:2 Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.
PSA 10:3 Bikos dem dey make mout about di evil tins wey dem dey do. Yes! Dem dey praiz pipol wey get long-trot and dey curse God.
PSA 10:4 Wiked pipol too sturbon and dem dey always tink sey, “God nor go do mi anytin, bikos E nor kare.”
PSA 10:5 Dem dey prosper for evritin wey dem dey do. Dem nor dey si yor ponishment wey dey wait dem. Dem dey laf doz wey bi dia enemies.
PSA 10:6 Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us! Wi go dey free from trobol forever!”
PSA 10:7 Na curse, lie and to treaten pipol, full dia mout. Na trobol and evil dey dia tongue.
PSA 10:8 Dem dey hide wait for di village gate; where nobody go for si dem kon kill innocent pipol and dem dey always fine and wound pipol wey nor get help.
PSA 10:9 Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.
PSA 10:10 Dem dey kill pipol wey nor get pesin wey go help dem; doz wey nor get pawa rish dem.
PSA 10:11 Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
PSA 10:12 So my God, make Yu raiz-up kon ponish wiked pipol! Make Yu nor leave doz wey nor get who go help dem!
PSA 10:13 Why wiked pipol dey go free sef, even wen dem nor respet God? Dem dey sey, “God nor go ever ask us sey wetin wi do.”
PSA 10:14 But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
PSA 10:15 Make Yu break wiked and evil pipol hand! Make Yu ponish dem for dia wiked plans wey dem tink sey Yu nor know about.
PSA 10:16 Na God bi king forever and ever! Di pipol wey nor dey fear God, go vanish komot from dis world.
PSA 10:17 Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.
PSA 10:18 Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress, so dat wiked pipol nor go ever treaten dem again.
PSA 11:1 David Song I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,
PSA 11:2 bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow.
PSA 11:3 So, naw wey di foundashon don skata, wetin good pipol go fit do?”
PSA 11:4 But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.
PSA 11:5 God dey si both good and bad pipol. E hate doz wey love wahala.
PSA 11:6 E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.
PSA 11:7 God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.
PSA 12:1 David Song My God, make Yu diliver mi! Bikos all doz wey dey fear and respet Yu, wiked pipol don kill dem finish.
PSA 12:2 Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.
PSA 12:3 Make God kut di tongue wey dey tok anyhow kon distroy di mout wey dey boast!
PSA 12:4 Dem dey sey, “Na di way wi dey tok, dey make us prosper; na wi get awa own lip: who bi awa oga or who go fit stop us?”
PSA 12:5 So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
PSA 12:6 God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire.
PSA 12:7 So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress. Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well,
PSA 12:8 even from doz evil pipol wey dey evriwhere, bikos wikedness don kover di whole land.
PSA 13:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?
PSA 13:2 How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart? Na how long my enemies go always dey opress mi?
PSA 13:3 My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.
PSA 13:4 Make Yu nor let my enemies dey make mout sey, “Wi don win am!” Den dem go dey happy sey I don fall.
PSA 13:5 But I trust yor love wey nor dey fail. I go happy, bikos Yu don save mi.
PSA 13:6 Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.
PSA 14:1 For Di Kwayamasta: David Song Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem nor good at-all and dia ways bad well-well. No one among dem dey do wetin good!
PSA 14:2 God dey look evribody from heaven; E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.
PSA 14:3 But e nor dey, bikos evribody don turn from am; evribody don spoil finish. Nobody dey do good again. Yes! E nor get anybody at-all.
PSA 14:4 Doz wey dey do bad nor go ever learn? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor dey pray to God.
PSA 14:5 So fear go katch dem, bikos God dey with di pipol wey dey obey am.
PSA 14:6 Even doh wiked pipol dey fight poor pipol, God go guide and protet dem.
PSA 14:7 E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
PSA 15:1 David Song My God, na who go fit woship for yor temple? Na who go enter yor present for yor holy hill?
PSA 15:2 Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite; pipol wey dey tok trut with pure heart.
PSA 15:3 Doz wey nor dey judge odas, wound dia neighbours or tok bad about dia friends.
PSA 15:4 Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God! Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.
PSA 15:5 Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head. Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.
PSA 16:1 David Prayer My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.
PSA 16:2 I tell my Oga God, “Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get, na Yu give dem to mi.”
PSA 16:3 Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.
PSA 16:4 Pipol wey dey run follow oda gods, dia trobol dey plenty evriday. I nor go follow dem do dia blood sakrifice or even koll dia god name.
PSA 16:5 My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.
PSA 16:6 Evritin dey work for my good! True-true, E don bless mi well-well.
PSA 16:7 So I go bless God wey dey guide mi; even for nite, my heart dey happy to praiz am.
PSA 16:8 I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.
PSA 16:9 No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.
PSA 16:10 Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.
PSA 16:11 Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.
PSA 17:1 David Prayer My Oga God, make Yu hear my kry for help, den judge my kase. Listin to my prayer, bikos na trut I dey tok.
PSA 17:2 Show sey I dey innocent, bikos Yu dey si doz wey dey rite.
PSA 17:3 Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart. Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong. I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
PSA 17:4 I don follow yor kommand wey nor let mi follow wiked and bad pipol.
PSA 17:5 Na only yor ways I dey follow; I neva stop to follow Yu.
PSA 17:6 My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa. Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.
PSA 17:7 Make Yu use yor wonders take show mi yor love wey nor dey fail. Yu don save doz wey kom meet Yu for help. Yu save dem from dia enemies with yor mighty pawa.
PSA 17:8 Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.
PSA 17:9 Make Yu protet mi from wiked pipol wey dey attack mi; from wiked enemies wey gada round mi,
PSA 17:10 bikos dem nor dey sorry for pesin. Make Yu hear as dem dey boast!
PSA 17:11 Dem don gada round mi naw dey wait to trow mi for groun.
PSA 17:12 Dem bi like lion wey dey hongry and dem nor fit wait to tear mi to pieces. Yes! Dem bi like yong lion wey hide for bush.
PSA 17:13 My Oga God, make Yu raiz-up! Make Yu stand against dem kon nak dem fall! Make Yu use yor swod take save mi from wiked pipol!
PSA 17:14 My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.
PSA 17:15 Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.
PSA 18:1 David Song Wen God Save Am From Saul My God, I love Yu well-well and na Yu bi my strent.
PSA 18:2 Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.
PSA 18:3 I koll God wey get all di praiz and E save mi from my enemies.
PSA 18:4 Deat dey round mi and trobol won kill mi;
PSA 18:5 na so-so grave I dey dream about and na to die, dey hongry mi.
PSA 18:6 But inside my trobol, I kry to God. Yes! I pray to my God make E kom help mi and E hear mi from en temple, bikos my kry rish en ear.
PSA 18:7 Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex.
PSA 18:8 Smoke dey kom out from dia nose; fire dey pour kom out from dia mout with hot shako.
PSA 18:9 So, God open di heavens kon kom down and dark kloud dey under en leg.
PSA 18:10 E sidan on-top angel feada kon fly go; E fly go with strong breeze.
PSA 18:11 E kon hide ensef for darkness and na di strong dark kloud E take round ensef.
PSA 18:12 Betta tick kloud kover di lite wey dey round am and many stones and shako kon dey fall.
PSA 18:13 God vois from heaven bi like tonda and evribody dey hear as di Most High dey shaut.
PSA 18:14 E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.
PSA 18:15 Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.
PSA 18:16 E kom down from heaven kon save mi, den E drag mi kom out from deep wota.
PSA 18:17 E save mi from my enemies wey get pawa well-well; from doz wey hate and too strong for mi.
PSA 18:18 Dem attack mi wen I dey trobol, but God support and help mi.
PSA 18:19 E take mi go where dey save; E save mi, bikos E love mi.
PSA 18:20 God reward mi, bikos I do wetin dey rite; E bring mi kom back, bikos I dey innocent and
PSA 18:21 bikos I dey always keep en kommand. I neva ever turn from my God kon follow evil.
PSA 18:22 I dey follow all en rules and I neva ever rijet en laws.
PSA 18:23 For God present, I nor do any bad tin; I don keep mysef from sin.
PSA 18:24 God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E don si sey I dey innocent.
PSA 18:25 E dey show ensef sey E dey faithful to doz wey dey faithful and to doz wey get respet, Yu dey give dem respet.
PSA 18:26 To pipol wey get pure heart, Yu dey show dem as Yu pure rish, but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
PSA 18:27 Yu save gentol pipol, but dey disgrace proud pipol.
PSA 18:28 Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness.
PSA 18:29 With yor pawa, I fit kill many sojas. With my God wey dey my side, I fit jump pass any wall.
PSA 18:30 God ways dey pafet and all en promise na true. E dey guide evribody wey kom make E protet am.
PSA 18:31 Na who bi God escept God? Na who again bi Solid Rock escept awa God?
PSA 18:32 God make mi strong with en strent and E make my way strait.
PSA 18:33 E make my leg strong for groun like deer own kon make mi fit stand on-top high mountins.
PSA 18:34 E train my hand, so dat I go fit fight war kon bend even di bow wey strong pass.
PSA 18:35 My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi.
PSA 18:36 Yu don make betta road for mi, so dat I nor go draw fall.
PSA 18:37 I porshu my enemies kon katch dem and I nor stop until I distroy dem finish.
PSA 18:38 I kill all of dem finish and all of dem fall under my leg.
PSA 18:39 Yu don give mi strent to fight war; Yu don put my enemies under my leg.
PSA 18:40 Yu put my leg for dia neck and I don distroy evribody wey hate mi.
PSA 18:41 Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom. Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.
PSA 18:42 I grind dem till dem turn to dust kon swip dem enter gutta like dirty.
PSA 18:43 Yu make mi win doz wey dey akuiz mi. Yu make mi rule oda nashons and pipol wey I nor even know, dey serve mi.
PSA 18:44 Wons dem hear about mi, dem dey obey. Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi.
PSA 18:45 Dem nor get strent again and dem even dey fear for dia house.
PSA 18:46 God dey alive! So, make praiz bi my Rock own and I go bless my God wey save mi!
PSA 18:47 Na en bi di God wey dey ponish doz wey wound mi. E put di nashons under mi
PSA 18:48 kon save mi from my enemies. E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi kon save mi from wiked pipol.
PSA 18:49 Bikos of dis, I go praiz God among di nashons; I go sing praiz to en name.
PSA 18:50 Yu don give betta viktory to yor king; Yu don show yor love wey nor dey fail to David wey Yu anoint and to en shidren-shidren forever.
PSA 19:1 For Di Kwayamasta: David Song Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.
PSA 19:2 Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.
PSA 19:3 Dem nor dey tok out or sey pesin hear dia vois,
PSA 19:4 yet dia vois don rish evriwhere for di eart and dia word don pass evriwhere for di world. God don build house for di sun for heaven
PSA 19:5 and e dey shine kom out like man wey just marry. E dey happy like pesin wey dey ready to run race.
PSA 19:6 Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.
PSA 19:7 God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.
PSA 19:8 God kommands dey rite and e dey put joy for pesin heart. En kommands dey klear and e dey give pesin hope to stay for dis world.
PSA 19:9 To fear God dey good, bikos e dey give pesin hope forever. God laws korrect and dem dey okay.
PSA 19:10 Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.
PSA 19:11 Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem, go get betta reward.
PSA 19:12 So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.
PSA 19:13 Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.
PSA 19:14 My Oga God wey bi my Rock and Savior, make di word from my mout and di tins wey I dey tink, dey good for yor eye and sweet Yu well-well.
PSA 20:1 For Di Kwayamasta: David Song Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help. Make Jakob God name, save yu from all wahala.
PSA 20:2 Make E kom help yu from en temple, den give yu pawa from Jerusalem.
PSA 20:3 Make E remember all di gifts wey yu gi-am, den favor yu, bikos of yor ofrins.
PSA 20:4 Make E do evritin wey yu wont and make yu prosper for evritin wey yu dey do.
PSA 20:5 Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound kon raiz awa banner wey dey show awa God name. Make God ansa all awa prayers.
PSA 20:6 Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint. E ansa di king from en heaven wey dey holy kon save am with en great pawa.
PSA 20:7 Some nashon dey make mout and trust dia shariot and sojas, but na awa Oga God name wi take dey boast.
PSA 20:8 Doz nashon go fall skata for groun, but wi go raiz kon stand gidigba for groun.
PSA 20:9 God, make Yu give viktory to awa king kon ansa awa kry for help.
PSA 21:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa! E dey happy and shaut, bikos Yu make am win.
PSA 21:2 Yu don gi-am evritin where e wont and na evritin wey e ask for, Yu gi-am.
PSA 21:3 Na suksess and progress Yu take welkom am back kon put one fine gold crown for en head.
PSA 21:4 Wen e sey make Yu save en life, Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever.
PSA 21:5 Yor viktory dey gi-am betta honor. Viktory with majesty wey make evribody know am for evritin.
PSA 21:6 Yor blessing bi like klot for en body and Yu gi-am joy for yor present.
PSA 21:7 Bikos di king trust God, en love wey nor dey fail, nor go let di king fall.
PSA 21:8 Di king go katch all en enemies. E go seize evribody wey hate am with en strong rite hand.
PSA 21:9 Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well. God go vex distroy dem for di fire.
PSA 21:10 Yu go distroy dia shidren-shidren from dis world and dem nor go ever get shidren again.
PSA 21:11 Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work.
PSA 21:12 Dem go turn and run from Yu, bikos of yor arrow wey Yu shot.
PSA 21:13 My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.
PSA 22:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, my God, wetin make Yu forget mi? Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?
PSA 22:2 My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
PSA 22:3 Yu dey holy and na Yu get all di praiz for Israel.
PSA 22:4 Awa grand-grand papa dem trust Yu and Yu save dem.
PSA 22:5 Dem kry give Yu and Yu diliver dem. Dem trust Yu and Yu nor ever disgrace dem.
PSA 22:6 But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!
PSA 22:7 Anybody wey si mi, dey laf mi. Dem go look mi kon shake dia head sey,
PSA 22:8 “Nor bi dis man trust God? Make God save am naw! If God love am well-well, make E kon diliver am naw!”
PSA 22:9 Yet Yu allow my mama born mi well and I trust Yu from small pikin.
PSA 22:10 Dem born mi put for yor hand and na Yu dey kare for mi. Na Yu bi my God from di time wen dem born mi kom rish naw.
PSA 22:11 So, make Yu nor too stay far from mi, bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.
PSA 22:12 My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan. Dem gada won bite mi!
PSA 22:13 Dem dey open dia mout against mi like lion wey dey hongry.
PSA 22:14 My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata. My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.
PSA 22:15 My strent don dry like mold wey sun beat. My tongue don gum my mout. Yu don trow mi for groun kon leave mi make I die for der.
PSA 22:16 My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi. Dem don shuk my hand and leg.
PSA 22:17 Naw, I fit kount all my bones and my enemies dey laf as dem dey look mi.
PSA 22:18 Dem divide my klot among demsef. Dem trow dice take divide my garment.
PSA 22:19 My God, nor dey far from mi! Na Yu bi my strent; make Yu kwik kom save mi!
PSA 22:20 Make Yu save mi from di swod kon guide my life from doz dogs.
PSA 22:21 Take mi komot from di lion mout and from di wiked melu horn.
PSA 22:22 I go tok about yor name for where my kountry pipol dey. I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
PSA 22:23 Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am! All Jakob shidren-shidren, make una kom make wi honor am!
PSA 22:24 Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa. E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.
PSA 22:25 I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
PSA 22:26 Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
PSA 22:27 Di whole eart go know God kon run go meet am. Evribody for di world go bow woship am.
PSA 22:28 Bikos na God bi di king wey get pawa and E dey rules evry nashon.
PSA 22:29 Make rish pipol for di world kom woship am. Evribody must bow to am, plus doz wey don die and doz wey nor fit save dia own life.
PSA 22:30 Awa shidren sef go serve Yu. Awa shidren-shidren go hear about di wonders wey God don do.
PSA 22:31 Dem go tell doz wey dem neva born naw about all di good tins wey God dey do. Dem go hear about evritin wey E don do.
PSA 23:1 David Song Just as shepad dey guide en sheep, na so too God dey guide and provide for mi; so hongry nor go kill mi.
PSA 23:2 E dey make mi rest for where good tins dey kon take mi pass river wey kwayet.
PSA 23:3 E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.
PSA 23:4 Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
PSA 23:5 E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.
PSA 23:6 True-true, en goodness and love wey nor dey fail go dey follow mi till I die and I go dey for God house forever and ever.
PSA 24:1 David Song Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
PSA 24:2 E build di eart foundashon on-top sea kon make am stand on-top wota.
PSA 24:3 Na who go fit klimb go God mountin? Na who go fit stand for en Holy Place?
PSA 24:4 Na only doz wey get klean hand and pure heart; pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.
PSA 24:5 Dem go get God blessing kon bi di God wey dey save dem, friend.
PSA 24:6 Dis kind pipol dey go find and woship am, bikos na-im bi di Oga wey bi Jakob God.
PSA 24:7 Naw, evry old gate, make una open! Evry old door, make una open, so dat di King wey get glory go enter inside.
PSA 24:8 Who bi dis King wey get glory? Na God wey dey strong and get pawa well-well; God wey get pawa to fight war.
PSA 24:9 Naw, evry old gate, make una open! Evry old door, make una open, so dat di King wey get glory go enter inside.
PSA 24:10 Who bi dis King wey get glory? Na di Oga God of all ogas; Na-im bi di King wey get glory.
PSA 25:1 David Song My God, na only Yu I dey depend on.
PSA 25:2 Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.
PSA 25:3 Nobody wey trust Yu dey si disgrace, but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.
PSA 25:4 My God, make Yu show mi di rite way kon point di road wey I go follow.
PSA 25:5 Make Yu tish mi, so dat I go know di trut, bikos na Yu bi di God wey save mi and evriday, I dey put my hope for yor hand.
PSA 25:6 My God, remember yor kindness and love wey nor dey fail, wey Yu dey show us, since awa grand-grand papa time.
PSA 25:7 Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.
PSA 25:8 God dey good and E dey do wetin dey rite; E dey show di rite road to pipol wey dey waka lost.
PSA 25:9 Doz wey dey honbol, E dey help dem do wetin dey rite, bikos E dey tish dem en ways.
PSA 25:10 All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.
PSA 25:11 My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.
PSA 25:12 How wi go take know doz wey dey fear God? Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow.
PSA 25:13 Dem go prosper and dia shidren go inherit di land.
PSA 25:14 God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.
PSA 25:15 Na God I always dey look up to, bikos na-im save mi from di trap wey my enemies set.
PSA 25:16 Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.
PSA 25:17 My problems dey worse evriday. So, make Yu save mi from wahala!
PSA 25:18 Make Yu feel my pains kon si my trobol, den Yu go forgive mi all my sins.
PSA 25:19 Si as my enemies many pass mi and as dem hate mi rish!
PSA 25:20 Make Yu protet mi! Make Yu save my life from dem! Nor let mi si shame, bikos na only Yu go fit save mi.
PSA 25:21 As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
PSA 25:22 So my God, make Yu save Israel pipol from all dia trobols.
PSA 26:1 David Song My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.
PSA 26:2 O my God, make Yu look mi well-well, den test my heart, so dat Yu go know wetin I dey tink.
PSA 26:3 Bikos I dey sure about yor love wey nor dey fail and I dey live my life, just as Yu sey make I leave am.
PSA 26:4 I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.
PSA 26:5 I hate to dey where bad pipol dey and I nor go ever follow wiked pipol waka.
PSA 26:6 My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar
PSA 26:7 kom tank and tell Yu about all di wonderful tins wey Yu don do.
PSA 26:8 Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.
PSA 26:9 Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.
PSA 26:10 Dia hands dirty with di wiked tins wey dem don do and dem dey always take bribe.
PSA 26:11 But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi.
PSA 26:12 Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu, so I go praiz my God.
PSA 27:1 David Song Na God bi my lite and my salvashon, so na who I go kon dey fear? Na en dey guide and protet mi from danger, so wetin go make mi dey shake?
PSA 27:2 Wen wiked pipol and my enemies won kom attack and kill mi, dem dey stagga fall.
PSA 27:3 Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear. Even if dem attack mi, I don go shek at-all.
PSA 27:4 Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.
PSA 27:5 Bikos E go must guide mi wen trobol kom kon hide mi for en temple. E go put mi on-top one high rock where nobody go fit tosh mi.
PSA 27:6 Den I go win my enemies wey gada round mi! I go offa sakrifice for dis temple and shaut for joy! I go dey sing and praiz my Oga God.
PSA 27:7 So my God, make Yu hear my prayer. Make Yu show mi mesi!
PSA 27:8 My heart sey make I pray to Yu and I kon pray to Yu my Oga and God.
PSA 27:9 Make Yu nor rijet mi. Nor vex push yor savant komot from yor present, bikos na Yu dey diliver mi. So, make Yu nor leave or abandon mi, bikos na Yu dey fight for mi.
PSA 27:10 Even if my papa and mama abandon mi, God go hold mi klose.
PSA 27:11 My God, make Yu tish mi how I go live my life and bikos my enemies hide for korna dey wait to distroy mi, make Yu lead mi pass di rite road.
PSA 27:12 Nor let mi fall enter dia hand, bikos dem dey akuiz mi for wetin I nor do and dem always dey treaten mi.
PSA 27:13 But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?
PSA 27:14 So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.
PSA 28:1 David Song I dey pray to Yu, my God wey bi my rock. Make Yu ansa mi. Bikos if Yu kwayet, life go taya mi and I go kwik die.
PSA 28:2 Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help and as I lift up my hand for yor holy temple.
PSA 28:3 Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked; doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour, but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.
PSA 28:4 Make Yu ponish dem for dia wikedness! Ponish dem akordin to di bad tins wey dem do, den reward dem for all dia wiked plans!
PSA 28:5 Dem nor kare about di tins wey God do or wetin God make with en own hand. So, God go skata dem finish and dem go disappear forever!
PSA 28:6 I go praiz God, bikos E don hear my kry for help!
PSA 28:7 Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.
PSA 28:8 God dey give en pipol strent and en king dey save, bikos E dey protet am.
PSA 28:9 So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.
PSA 29:1 David Song Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.
PSA 29:2 Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness.
PSA 29:3 God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.
PSA 29:4 God vois get pawa well-well; en vois get glory.
PSA 29:5 God vois dey break mighty cedar tree! Yes, e dey skata cedar trees for Lebanon.
PSA 29:6 E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu.
PSA 29:7 God vois dey kom with strong lite.
PSA 29:8 God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.
PSA 29:9 God vois dey bend big trees and skata leaf for forest. Evribody for di temple dey sey, “Make glory bi yor own!”
PSA 29:10 Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.
PSA 29:11 Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.
PSA 30:1 Song Wey David Take Dedikate Di Temple My God, I go praiz Yu, bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.
PSA 30:2 My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.
PSA 30:3 My God, Yu don bring mi kom out from grave. Yu keep mi, so dat I nor go fall inside pit where dead body dey.
PSA 30:4 All of una wey dey fear God, make una sing to am!
PSA 30:5 Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.
PSA 30:6 Dat time wen I don get evritin wey I nid, den I go kon sey, “Nor-tin go fit make mi poor again!”
PSA 30:7 But my God, wen yor favor don sikure mi like mountin, Yu kon turn from mi and evritin wey I get kon skata.
PSA 30:8 My God, I dey kry and beg Yu for mesi kon sey,
PSA 30:9 “Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?
PSA 30:10 My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi. Make Yu kom help mi.”
PSA 30:11 Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,
PSA 30:12 so dat I go sing praiz Yu and I nor go kwayet. So, I go tank Yu wey bi my Oga and God forever!
PSA 31:1 For Di Kwayamasta: David Song My God, na Yu dey protet mi; so make Yu nor let pipol disgrace mi. Make Yu save mi, bikos Yu dey always do di rite tin.
PSA 31:2 Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi. Make Yu bi my rock wey go dey protet mi; di strong place where I fit hide put.
PSA 31:3 Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.
PSA 31:4 Drag mi komot from di trap wey my enemies set for mi, bikos na only Yu fit protet mi.
PSA 31:5 I don put my life for yor hand. So Oga God, make Yu diliver mi, bikos Yu bi God wey dey faithful.
PSA 31:6 I hate pipol wey dey serve juju, but I trust Yu wey bi my Oga God.
PSA 31:7 I go happy and dance for yor love wey nor dey fail, bikos Yu don si my trobol and Yu kare about di pains wey dey my heart.
PSA 31:8 Yu nor give mi to my enemies and Yu don put mi for where I go dey save.
PSA 31:9 My Oga God, make Yu sorry for mi, bikos I dey pass thru pain as I dey kry and my body and soul dey die dey go.
PSA 31:10 I dey die bikos pain and sadnes don make my years short. Sin don finish my strent and na die I dey die so.
PSA 31:11 All my enemies dey laf mi and my neighbours hate mi; even my friends dey fear to waka near mi and wen dem si mi dey kom, dem go rush pass anoda road.
PSA 31:12 Pipol don forget mi like sey I don die; like sey I bi pot wey break.
PSA 31:13 I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.
PSA 31:14 But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!
PSA 31:15 My future dey yor hand. Make Yu save mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi.
PSA 31:16 Make yor favor shine on yor savant. Make Yu save mi with yor love wey nor dey fail.
PSA 31:17 My God, nor let dem disgrace mi, bikos I dey koll make Yu kom help mi. Instead, make disgrace follow wiked pipol and make dem die go dia grave, where dem go dey silent forever.
PSA 31:18 Make Yu klose dia lie-lie mout forever; doz pipol wey get bad mout and dey akuiz God pipol.
PSA 31:19 Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
PSA 31:20 Yu dey guide and hide dem for yor present and dia enemies nor go fit tosh dem or lie for dia head.
PSA 31:21 Make praiz bi God own, bikos E don show mi di wonderful tins wey dey en love wey nor dey fail, wen E save mi from my enemies.
PSA 31:22 I kry to Yu as I dey fear kon sey, “Dem don take mi from Yu!” But Yu hear my kry for mesi kon ansa my prayer for help.
PSA 31:23 All of una wey dey fear and obey God, make una love am! Bikos God dey protet pipol wey dey loyal to am, but E dey vex ponish doz wey dey do wiked tins.
PSA 31:24 So evribody wey put dia trust for God hand, make una nor fear, instead make una get strong mind!
PSA 32:1 Betta Song Wey David Rite Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins, make e happy!
PSA 32:2 Yes, make doz wey God don forgive dia sins happy well-well; doz wey dey live betta life naw!
PSA 32:3 Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go and I kon dey kry with pain.
PSA 32:4 Both day and nite, God just dey ponish mi. My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.
PSA 32:5 So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!
PSA 32:6 So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey, so dat dem nor go sofa for judgement day.
PSA 32:7 Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.
PSA 32:8 God sey, “I go guide and take yu pass di best road for life. I go advise and wosh ova yu.
PSA 32:9 So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”
PSA 32:10 Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.
PSA 32:11 So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!
PSA 33:1 Una wey dey fear God, make una sing with joy; bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am.
PSA 33:2 Make una praiz God with di sweet sound from jita; make una use harp take sing to am.
PSA 33:3 Make una sing new song take praiz am; make una play di harp make e loud well-well.
PSA 33:4 Bikos God word na true and wi fit trust evritin wey E dey do.
PSA 33:5 E love anytin wey dey rite and good; God love wey nor dey fail, full di eart.
PSA 33:6 Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.
PSA 33:7 E gada di sea for one place kon keep di ocean for where e dey.
PSA 33:8 So, make di whole world fear God and make evribody kom bless en name.
PSA 33:9 Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.
PSA 33:10 God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.
PSA 33:11 But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.
PSA 33:12 Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.
PSA 33:13 God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate.
PSA 33:14 Evritin wey dey alive for dis eart, God dey look dem from en throne.
PSA 33:15 Na-im make dia heart, so E undastand evritin wey dem dey do or tink.
PSA 33:16 Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am, na so too pesin pawa nor go fit save am.
PSA 33:17 So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win, bikos with all en strent, e nor go fit save yu.
PSA 33:18 But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail.
PSA 33:19 E save dem from deat and keep dem alive wen honga dey.
PSA 33:20 Na God bi awa hope. Na-im dey help and guide us.
PSA 33:21 Awa heart dey always happy, bikos of am and wi trust en name wey dey holy.
PSA 33:22 My God, make yor love wey nor dey fail, protet us, bikos na Yu bi di hope wey wi get.
PSA 34:1 David Song Wen E Pritend Sey E Dey Kraze And Abimelek Kon Porshu Am I go always dey praiz God. I go always dey tok about all di good tins wey E dey do.
PSA 34:2 Na only God name I go take boast; so make doz wey dem dey opress, listin and happy well-well.
PSA 34:3 Kom make wi tok about how God great rish; kom make wi praiz en name togeda.
PSA 34:4 I pray to God and E ansa mi kon free mi from all my fear.
PSA 34:5 Doz wey dey go meet am make E help dem, go happy well-well and shame nor go ever katch dem.
PSA 34:6 I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
PSA 34:7 Bikos na God angel dey guide mi, na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.
PSA 34:8 Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!
PSA 34:9 Una wey bi God pipol, make una fear am, bikos doz wey dey fear am go get evritin wey dem nid.
PSA 34:10 Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
PSA 34:11 My shidren, make una kom listin to mi and I go tish una how to fear God.
PSA 34:12 E get anybody wey won live betta life? Anybody like to get long life?
PSA 34:13 Den make yu nor use yor mout take tok bad tin and make yor lips nor dey lie!
PSA 34:14 Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good. Make yu dey leave for peace with evribody and do evritin to keep am like dat.
PSA 34:15 Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
PSA 34:16 But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins; E dey remove dem from dis eart.
PSA 34:17 God dey hear en pipol wen dem koll am for help. E dey save dem from all dia wahala.
PSA 34:18 Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem; E dey save doz wey dia spirit dey die.
PSA 34:19 Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.
PSA 34:20 God dey protet en pipol well-well and E nor go let any bad tin happen to dem,
PSA 34:21 but wiked pipol go must face wahala and God go ponish doz wey hate en pipol.
PSA 34:22 God go save pipol wey dey serve am and E nor go kondemn anybody wey dey obey am.
PSA 35:1 David Song My God, make Yu oppoz doz wey dey oppoz mi and fight doz wey dey fight mi.
PSA 35:2 Make Yu wear yor war klot, ready for war, den kom save mi.
PSA 35:3 Make Yu lift yor spear and javelin against pipol wey dey porshu mi, den I go bilive wetin Yu tok sey, “Na mi wey bi God, go diliver yu!”
PSA 35:4 Make shame and disgrace follow pipol wey dey try to kill mi; make Yu drive dem back and disgrace doz wey won wound mi.
PSA 35:5 Make Yu blow dem trowey like leaf wey breeze blow and make yor angels porshu dem.
PSA 35:6 Make Yu make dia way dark and make groun draw dem fall, as God angel dey porshu dem,
PSA 35:7 bikos I nor do dem any bad tin, but dem dey set trap and dig pit to katch mi.
PSA 35:8 So make wahala kom meet dem at wons! Make di trap wey dem set for mi, katch dem! Make dem fall enter di pit wey dem dig for mi.
PSA 35:9 Den I go happy, bikos of my God. I go happy, bikos E save mi.
PSA 35:10 I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”
PSA 35:11 Wiked pipol dey lie for my head. Dem dey akuiz mi about bad tins wey I nor do.
PSA 35:12 Dem dey pay mi bad for di good wey I do and dia wahala dey make mi sick.
PSA 35:13 Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!
PSA 35:14 I dey mourn for dem, just as I go do for my broda or friend. I dey bow with sorrow like sey I dey mourn for my mama.
PSA 35:15 But wen I fall, dem go dey happy kon gada demsef togeda dey dance. Dem gada togeda to kause wahala for mi and dem nor gri stop or taya.
PSA 35:16 Dem dey laf and koll mi difren names; while some dey try to bite mi.
PSA 35:17 My God, na so Yu go just dey look dem? Yu nor go do anytin? Make Yu save mi from dis lions wey won kill mi!
PSA 35:18 Den I go tank Yu for where yor pipol gada put. I go praiz Yu for all yor pipol front.
PSA 35:19 Make Yu nor let my enemies happy sey dem win mi. Make Yu nor let pipol wey hate mi, even doh I nor do anytin, happy bikos I dey sofa.
PSA 35:20 Dem nor dey tok about peace. Dem dey plan against innocent pipol wey dey mind dia business.
PSA 35:21 Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o! Wi don get am at last!”
PSA 35:22 My God, Yu know all dis tins. So, make Yu nor just keep kwayet, make Yu nor live mi naw.
PSA 35:23 Make Yu raiz-up kom defend mi! My Oga God, make Yu take my matter like yor own.
PSA 35:24 Show sey I nor do anytin, bikos na Yu dey judge well. Make Yu nor let my enemies laf mi, bikos of di trobol wey I dey face.
PSA 35:25 Make Yu nor let dem sey, “Si, wi don get wetin wi wont! Wi go chop am alive!”
PSA 35:26 Make disgrace and shame follow pipol wey dey happy sey I dey sofa. Make nobody honor doz wey dey dance, bikos I dey sofa and make shame kover dem.
PSA 35:27 But make Yu give joy and happiness to pipol wey dey help mi. Make dem always dey sey, “God dey great and E wont make en savant dey save!”
PSA 35:28 Den I go tok about yor korrect judgement and I go praiz Yu forever.
PSA 36:1 David Song Wiked pipol nor get good heart and dem nor dey fear God.
PSA 36:2 Bikos dem blind, dem nor fit si as dem really wiked rish.
PSA 36:3 Evritin wey dem tok na lie and dem dey deceive pipol. Dem nor dey ever gri do good tins.
PSA 36:4 Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.
PSA 36:5 My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens; just as yor goodness high pass di kloud for sky.
PSA 36:6 Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.
PSA 36:7 My God, si as I value yor love wey nor dey fail! Evribody dey save under yor feada shadow.
PSA 36:8 Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house kon let dem drink from yor wota wey dey give life,
PSA 36:9 bikos na Yu bi di wota wey dey give life; di lite wey make us dey si.
PSA 36:10 Make Yu pour yor love wey nor dey fail on pipol wey love Yu; make Yu judge well for pipol wey get klean heart.
PSA 36:11 Nor let proud pipol opress mi or allow wiked pipol drive mi komot from my house.
PSA 36:12 Si! Wiked pipol don fall! God don trow dem down and dem nor go get up again.
PSA 37:1 David Song Make yu nor worry yorsef about wiked pipol wey dey prosper or jealous doz wey dey do bad tins!
PSA 37:2 Bikos dem go soon die like grass. Just as flower dey die for dry sizin, na so too dem go die trowey.
PSA 37:3 Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
PSA 37:4 Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.
PSA 37:5 Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand. Trust am and E go help yu.
PSA 37:6 E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.
PSA 37:7 So, make yu wait for God with patient! Make yu get mind as yu dey wait am! Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get.
PSA 37:8 Make yu nor dey vex, bikos na trobol, vexnashon dey bring.
PSA 37:9 God go distroy wiked pipol, but na doz wey trust God, go inherit di land.
PSA 37:10 Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
PSA 37:11 Doz wey dey honbol, go inherit di land and dem go get peace kon prosper.
PSA 37:12 Wiked pipol dey plan against God pipol; dem dey attack God pipol anyhow.
PSA 37:13 But God just dey laf, bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.
PSA 37:14 Wiked pipol dey use dia swod and bow take kill poor pipol, doz wey dem dey opress and doz wey dey raitious.
PSA 37:15 But dia swod go stab dia own heart and dia bows go break.
PSA 37:16 So e dey good to fear God with di small money wey pesin get, dan to do evil kon get money well-well.
PSA 37:17 God go take wiked pipol pawa, but E go protet doz wey dey fear am.
PSA 37:18 God dey guide innocent pipol evriday and dem go get propaty wey go last forever.
PSA 37:19 E nor go leave dem wen tins hard and even wen honga dey, dem go get enough food to chop.
PSA 37:20 But wiked pipol go die, bikos God enemies bi like flower for field wey go soon vanish like smoke.
PSA 37:21 Wen wiked pipol borrow sometin, dem nor dey pay back, but doz wey dey fear God dey give tins to pipol with happiness.
PSA 37:22 Na doz wey God bless go get di land, but doz wey E curse, go die.
PSA 37:23 God dey lead doz wey dey fear am. E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life.
PSA 37:24 Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall, bikos God hold dem with en hand.
PSA 37:25 Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old, I neva si God leave doz wey dey fear am or allow dia shidren go beg for food.
PSA 37:26 Dis pipol dey always happy to give and blessing dey follow dia shidren.
PSA 37:27 So, make yu turn from bad tins kon do good and yu go stay for di land forever.
PSA 37:28 Bikos God like to dey judge well and E nor go ever leave doz wey dey fear am.
PSA 37:29 Doz wey dey fear God go inherit di land and dem go stay der forever.
PSA 37:30 Doz wey dey fear God dey advise pipol well and dem dey tok wetin dey rite.
PSA 37:31 Dem don make God law dia own, so dem nor go ever sin.
PSA 37:32 Wiked pipol dey set trap for God pipol, dem dey find ways to take kill dem.
PSA 37:33 But God nor go let wiked pipol win or let dem kondemn doz wey dey fear am.
PSA 37:34 So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.
PSA 37:35 Pipol wey wiked and nor dey sorry for odas, I don si as dem dey prosper like tree for betta groun,
PSA 37:36 but wen I look again, I si sey dem don die go! Even doh I look evriwhere weda I go si dem, I nor si dem again!
PSA 37:37 So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good, bikos doz wey like peace go get betta future.
PSA 37:38 God go distroy wiked pipol and dem nor go si tumoro.
PSA 37:39 But God go save doz wey dey fear am and na-im go protet dem wen dem dey for trobol.
PSA 37:40 God go help and save dem from wiked pipol. E go save dem with en pawa and dem go dey save inside am.
PSA 38:1 David Prayer My God, make Yu nor porshu or ponish mi, bikos Yu dey vex!
PSA 38:2 Yor arrow don shuk mi. E don wound mi well-well
PSA 38:3 and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.
PSA 38:4 I dey die inside my own sin and dis wahala too heavy for mi to karry.
PSA 38:5 Bikos of my sins, di sore for my body don start to smell.
PSA 38:6 I nor fit stand strait again and wahala full my life. Evriday, I dey kry and mourn waka.
PSA 38:7 I dey shame well-well and na so-so sick I dey sick.
PSA 38:8 I don taya and my own don finish. I dey kry from my heart, bikos of all di pain for my body.
PSA 38:9 So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont. Yu dey hear as I dey kry with pain.
PSA 38:10 My heart dey beat fast-fast; my pawa don finish and my eye don blind.
PSA 38:11 Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
PSA 38:12 Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
PSA 38:13 But I bi like who nor dey hear wetin dem dey tok. I kwayet dey look dem like sey I nor sabi tok.
PSA 38:14 Naw, I bi like deaf to dem. I nor dey ready to kworel or ansa dem back.
PSA 38:15 But I dey wait for Yu, my God. My Oga God, make Yu kom ansa mi.
PSA 38:16 I dey pray, “Make Yu nor let my enemies happy, bikos I fall for groun.”
PSA 38:17 Na die I dey so o-o, bikos na so-so pain I dey face.
PSA 38:18 But naw, I dey konfess my sins; I really dey sorry for evritin wey I don do.
PSA 38:19 I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
PSA 38:20 Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.
PSA 38:21 So my God, make Yu nor leave mi. Nor stand for far dey look mi.
PSA 38:22 My God and Savior, make Yu kwik-kwik kom help mi.
PSA 39:1 David Rite Song Give Jedutun, Di Kwayamasta I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok. I go hold my tongue wen sinnas dey near mi.”
PSA 39:2 But even as I dey kwayet and nor tok wetin good or bad, my sorrow and pain still dey worse more-more.
PSA 39:3 Di more I dey tink about am, di more e dey pain mi for my heart; so I kon sey:
PSA 39:4 “My God, na how long I go dey dis life? Wen I go take die? Make Yu tell mi wen my life go end.
PSA 39:5 Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”
PSA 39:6 Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.
PSA 39:7 So, my God, where I won put my hope? Na Yu bi my only hope.
PSA 39:8 Make Yu save mi from my sins. Make Yu nor let fools laf mi.
PSA 39:9 I kwayet for yor present; I nor go tok anytin, bikos of wetin Yu don do.
PSA 39:10 But abeg, make Yu nor flog mi again! I don taya for di beat wey Yu dey beat mi.
PSA 39:11 Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.
PSA 39:12 My God, make Yu hear my prayers! Make Yu listin to my kry for help! Make Yu dey look di tears from my eye. I bi like pesin wey travel kom stay with Yu, just as my grand-grand papa dem bi to Yu.
PSA 39:13 Make Yu take yor vexnashon from mi, so dat I go fit smile again before I die.
PSA 40:1 David Song For Di Kwayamasta I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry.
PSA 40:2 E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka.
PSA 40:3 E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipol go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God.
PSA 40:4 Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju.
PSA 40:5 My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
PSA 40:6 Yu really don make mi undastand sey, nor bi only sakrifice and ofrin yu wont. True-true, Yu nor just wont only burnt or sin ofrin.
PSA 40:7 Den I sey, “Look, I don kom, just as dem rite about mi for yor Book sey:
PSA 40:8 ‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
PSA 40:9 I don tell yor pipol about how Yu dey judge. I nor dey fear to tok about all di good tins wey Yu don do.
PSA 40:10 All di good tins wey Yu do, I nor keep dem for my heart; but I don tok about as Yu dey faithful and yor pawa wey dey save pipol.
PSA 40:11 So Oga God, make Yu nor stop to dey sorry for mi. Make yor love and faith wey nor dey fail, always dey protet mi.
PSA 40:12 Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.
PSA 40:13 So my God, abeg, make Yu save mi! Make Yu kwik-kwik kom help mi.
PSA 40:14 Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem.
PSA 40:15 Make shame and disgrace follow dem, bikos dem sey, “Yes o-o! Wi don get am naw!”
PSA 40:16 But pipol wey dey find Yu, make joy and gladness full dia heart. Make doz wey love yor salvashon always dey shaut sey, “God dey great!”
PSA 40:17 I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.
PSA 41:1 David Song For Di Kwayamasta Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol! God dey always save dem from trobol.
PSA 41:2 Make God protet and keep dem alive. Make E make dem prosper for di land and save dem from dia enemies.
PSA 41:3 God dey kare for dem wen dem dey sick kon make dem well again.
PSA 41:4 My God, I dey pray sey, “Make Yu sorry for mi. Make Yu heal mi, bikos I don sin against Yu.”
PSA 41:5 Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi. Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”
PSA 41:6 Dem dey visit mi like sey dem bi my friends, but na wikedness full dia heart and wen dem komot from where I dey, dem go-go spoil mi give evribody.
PSA 41:7 Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi and na only bad tins dem dey tink about mi.
PSA 41:8 Dem sey, “E get some bad-bad diziz. E nor go ever get up from dat bed!”
PSA 41:9 Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.
PSA 41:10 So Oga God, make Yu sorry for mi. Make I well again, so dat I go pay dem back!
PSA 41:11 Like dis, I know sey I dey make belle sweet Yu, bikos Yu neva let my enemies win mi.
PSA 41:12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.
PSA 41:13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever.
PSA 42:1 David Song Wey Korah Shidren Sing My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
PSA 42:2 I dey hongry to know God! Di God wey dey alive. So na wen I go take stand for en front?
PSA 42:3 I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”
PSA 42:4 I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!
PSA 42:5 But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!
PSA 42:6 Naw, I nor get hope at-all, but I go remember Yu, even from Mount Hermon wey far and for Mount Mizar land wey dey Jordan River.
PSA 42:7 I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
PSA 42:8 But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.
PSA 42:9 I dey kry dey sey, “My God wey bi my rock, wetin make Yu forget mi? Wetin go make mi dey waka with pains bikos my enemies dey opress mi?”
PSA 42:10 Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”
PSA 42:11 Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!
PSA 43:1 My God, make Yu show sey I dey innocent! Save mi from pipol wey nor dey fear Yu. Diliver mi from doz wey dey lie,
PSA 43:2 bikos na Yu bi di God wey dey save mi. But wetin make Yu rijet mi? Why I go dey waka with pains, bikos my enemies dey opress mi?
PSA 43:3 Make Yu send yor lite and trut kon guide mi. Make dem karry mi go yor holy mountin, di place wey Yu dey stay.
PSA 43:4 For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!
PSA 43:5 Wetin make my soul dey weak? Wetin make my heart nor happy at-all? But I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and God!
PSA 44:1 David Song Wey Korah Shidren Sing My God, wi don hear am with awa own ear and awa grand-grand papa dem don tell us about evritin wey Yu do for dia time.
PSA 44:2 Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa.
PSA 44:3 Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.
PSA 44:4 Na Yu bi my King and God. Na Yu make Israel pipol win.
PSA 44:5 Na yor pawa wi go take porshu awa enemies; na yor name wi dey take mash dem for groun.
PSA 44:6 I nor trust my bow, I nor put hope sey my swod go save mi,
PSA 44:7 but na Yu make us fit win awa enemies kon disgrace doz wey hate us.
PSA 44:8 My God, wi go always dey give Yu glory and praiz yor name forever and ever.
PSA 44:9 But naw, Yu don rijet and disgrace us. Yu nor dey follow awa sojas go fight again.
PSA 44:10 Yu make us run from awa enemies kon allow pipol wey hate us, pak awa propaty.
PSA 44:11 Yu don busher us give dem like animal wey dem won chop kon skata us among di nashons.
PSA 44:12 Na one-one kobo Yu sell yor special pipol and Yu nor gain anytin from inside.
PSA 44:13 Yu don let awa neighbours dey laf us. Pipol wey dey around dey take us make yeye.
PSA 44:14 Yu don make us di topik for dia joke; dem dey shake dia head for us like sey wi bi fools.
PSA 44:15 Na sofa and curse bi my own evriday; dem don rite shame put for my fore head.
PSA 44:16 Doz wey dey laf mi, na only dia vois I dey always hear and na only my enemies wey dey ponish mi, I dey si.
PSA 44:17 Even doh all dis tins dey happen to us, wi neva forget Yu. Wi neva go against yor kovenant.
PSA 44:18 Na only Yu dey awa heart and wi still dey follow yor ways.
PSA 44:19 Yu don skata us for groun like dirty wey dog dey run pass; Yu don kover us with darkness.
PSA 44:20 If wi don rijet awa Oga God kon dey pray to anoda god,
PSA 44:21 E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.
PSA 44:22 Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill.
PSA 44:23 So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.
PSA 44:24 Why Yu dey look di oda side? Wetin make Yu do like sey Yu nor know sey wi dey sofa and wiked pipol dey opress us?
PSA 44:25 Wi don faint for groun kon sleep for dirty.
PSA 44:26 So my God, make Yu kom help us! Save us bikos of yor love wey nor dey fail.
PSA 45:1 David Love Song Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.
PSA 45:2 Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.
PSA 45:3 My strong warrior! Make yu karry yor swod kon appear with yor glory and majesty!
PSA 45:4 Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.
PSA 45:5 Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg.
PSA 45:6 My God, yor throne go dey forever and ever. Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom.
PSA 45:7 Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.
PSA 45:8 Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.
PSA 45:9 Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!
PSA 45:10 All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.
PSA 45:11 Bikos una prince dey happy for una beauti. Make una honor am, bikos na-im bi una oga.
PSA 45:12 Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.
PSA 45:13 Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot wey dem make with gold.
PSA 45:14 Den dem go take am go meet di king as e wear di fine klot with di virgins wey follow am for back
PSA 45:15 and dem go happy dey celebrate as dem dey enter di king palis!
PSA 45:16 Dia sons go bi king afta dia papa and dem go rule ova many lands.
PSA 45:17 I go make evry generashon honor and remember yor name and pipol go praiz yu forever and ever.
PSA 46:1 David Song Wey Korah Shidren Sing Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.
PSA 46:2 Bikos of dis, wi nor dey fear wen di eart dey shake or wen mountins dey fall enter sea.
PSA 46:3 River dey make betta nois and mountins dey shake for di strong sea.
PSA 46:4 Di wota from di river dey bring joy kom God town; di special and holy place where di Holy One dey stay.
PSA 46:5 Bikos God dey stay di town, e nor go skata. Na from wen day just break, God dey protet am.
PSA 46:6 Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!
PSA 46:7 God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.
PSA 46:8 So make una kom si all di wonderful tins wey God don do. Make una si how E dey make di world konfuse.
PSA 46:9 E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.
PSA 46:10 God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”
PSA 46:11 God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.
PSA 47:1 David Song Wey Korah Shidren Sing Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!
PSA 47:2 Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart.
PSA 47:3 E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg.
PSA 47:4 E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love.
PSA 47:5 God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.
PSA 47:6 So, make una sing praiz God; make una praiz am; make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am!
PSA 47:7 Na God bi di King for all di eart. Make una praiz am with psalms!
PSA 47:8 Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne.
PSA 47:9 Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world.
PSA 48:1 David Song Wey Korah Shidren Sing Si as awa God great rish! Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin!
PSA 48:2 Di mountin dey high and fine well-well; di whole eart dey happy to si am! Mount Zion wey bi di holy mountin, na-im bi di town where di great King dey stay!
PSA 48:3 God ensef dey for Jerusalem towa and na-im dey defend us.
PSA 48:4 Di kings for di eart join togeda kon fight di town.
PSA 48:5 But wen dem si am, dia heart kut and fear katch dem, so dem kon run go back.
PSA 48:6 Fear katch dem well-well and dem kon dey kry with pain like woman wey won born.
PSA 48:7 Yu skata dem like di big sheep for Tarshish wey Yu distroy with di wind from east.
PSA 48:8 Wi don hear about di town glory, but naw, wi don si am by awasef; di town wey God wey dey lead heaven sojas, dey and bikos na awa God town, E go protet am forever.
PSA 48:9 My God, as wi dey woship for yor temple, wi go always dey tok about yor love wey nor dey fail.
PSA 48:10 My God, as yor name bi, na so dem go praiz Yu for evriwhere for di eart. Na viktory full yor strong rite hand.
PSA 48:11 Make Zion pipol rijoice. Make all di towns for Judah happy, bikos of di way God dey judge.
PSA 48:12 Make una go look Jerusalem; waka round and kount all di towas.
PSA 48:13 Make una si as di town walls strong rish and as e dey save, den una go fit tell una shidren-shidren about am.
PSA 48:14 Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.
PSA 49:1 David Song Wey Korah Shidren Sing Evribody, make una listin to wetin I won tok! Evribody for di world, make una put una ear for groun!
PSA 49:2 Pipol wey get money and pipol wey nor get, make una listin!
PSA 49:3 Bikos wetin I dey tok, dey good and wetin I dey tish, dey give pipol wisdom.
PSA 49:4 I go listin to many proverbs and play jita take solve many problems.
PSA 49:5 So, wetin go make mi fear wen trobol kom or wen enemies gada round mi?
PSA 49:6 Dem bilive dia money kon dey boast with all di tins wey dem get.
PSA 49:7 Yet dem nor fit save demsef from deat or pay God for dia life:
PSA 49:8 (true-true, e nor get any money wey pesin fit take buy human being life, bikos evribody must die)
PSA 49:9 since dem nor go dey alive forever, bikos dem go must die one day.
PSA 49:10 Wi know sey even wise pipol must die; both fools and doz wey dey spiritual still dey die too and na odas go kollect evritin plus di money wey dem get.
PSA 49:11 Dia grave go kon bi where dem go stay forever. Dem give dia land dia name,
PSA 49:12 but with all di money wey dem get, dem must still die; dem bi like animals wey dey die trowey.
PSA 49:13 Dis na wetin go happen to fools and pipol wey bilive wetin dem dey tish.
PSA 49:14 Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.
PSA 49:15 But for mi, God go save my life. E go save mi from deat.
PSA 49:16 So make wi nor dey judge or vex bikos wiked pipol get money or get fine house.
PSA 49:17 Bikos wen dem die, dem nor go take anytin follow body. Dia money and evritin wey dem get, nor go follow dem enter grave.
PSA 49:18 For dis life, dem dey happy sey dem get evritin kon dey klap for dia suksess,
PSA 49:19 but dem go die like doz wey don die before and dem nor go ever si day lite again.
PSA 49:20 Pipol wey dey make mout about dia money, nor undastand anytin at-all; bikos dem go die, just as animal dey die too.
PSA 50:1 Asaf Song Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.
PSA 50:2 From Mount Zion wey fine well-well, God dey shine inside en glory.
PSA 50:3 Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all. Fire dey burn evritin wey dey en way and strong breeze wey dey make nois, dey round am.
PSA 50:4 E dey koll di heavens wey dey up and di eart wey dey under, so dat dem go bi witness wen E dey judge en pipol.
PSA 50:5 E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom, doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.
PSA 50:6 Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.
PSA 50:7 My pipol, make una listin as I dey tok. Israel pipol, dis na wetin I get against una, na Mi bi di Oga wey bi una God!
PSA 50:8 I nor dey komplain about una sakrifice or di burnt ofrin wey una always dey offa.
PSA 50:9 I nor nid di melu from una house again or wont di goat from una farm.
PSA 50:10 Bikos na mi get all di animals for forest and all di many goats wey dey di hills.
PSA 50:11 I know all di birds for di mountin and all di animals for di field, na my own too.
PSA 50:12 If to sey I dey hongry, I nor go tell una, bikos na mi get di world and evritin wey dey inside.
PSA 50:13 I dey chop melu meat? Abi I dey drink goat blood?
PSA 50:14 So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.
PSA 50:15 Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”
PSA 50:16 But God tell wiked pipol: “Wetin make una dey learn my laws and dey pritend sey una dey obey my kovenant?
PSA 50:17 Una nor gri listin to my kommand, instead una dey do my word anyhow like dirty.
PSA 50:18 Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.
PSA 50:19 Na so-so wiked tins full una mout and na lie-lie full una tongue.
PSA 50:20 Una go just sidan dey tok bad about una broda; di pikin wey una own mama born.
PSA 50:21 As una dey do all dis tins, I nor tok at-all and una feel sey I nor kare. But naw, I go distroy una kon rite evritin wey I get against una.
PSA 50:22 All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.
PSA 50:23 But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”
PSA 51:1 David Song For Di Kwayamasta Afta E Sleep With Batsheba My God, make Yu sorry for mi, bikos of yor love where nor dey fail. Make Yu forgive mi my sins, bikos Yu dey sorry for pipol.
PSA 51:2 Make Yu wosh and klean mi from di bad tins wey I do. Klean mi from all my sins.
PSA 51:3 I know sey I do many bad tins; bikos I really know all di sins wey I dey kommit.
PSA 51:4 I don really sin against Yu; I don do bad tins for yor present. Evritin wey Yu dey tok dey rite and di way Yu take judge my kase, dey good.
PSA 51:5 Si, na for inside sin, dem born mi; Yes! Na rite from di time wey my mama get my belle.
PSA 51:6 But even before dem born mi, Yu don plan betta tins for mi kon dey tish mi wisdom.
PSA 51:7 So make Yu klean mi from my sins and I go dey klean; make Yu wosh mi and I go white pass snow.
PSA 51:8 My God, make Yu give mi my joy back and make my bones wey Yu break, strong again.
PSA 51:9 Make Yu nor kontinue to dey look my sins, but klean mi from all di bad tins wey I don do.
PSA 51:10 My God, make Yu put betta heart inside mi and make yor spirit strong inside mi too.
PSA 51:11 Nor drive mi komot from yor present or take yor holy spirit from mi.
PSA 51:12 Make Yu give mi back di joy wey make mi dey save, so dat I go dey happy to obey Yu.
PSA 51:13 Den I go tish wiked pipol yor ways and dem go turn kom meet Yu.
PSA 51:14 My God wey dey save pesin, make Yu forgive mi, bikos I don kill pesin; den I go sing about yor forgivenes with joy.
PSA 51:15 My God, make Yu open my lips, so dat my mout go praiz Yu.
PSA 51:16 Nor bi sakrifice or burnt ofrin yu wont, if not, I for offa sometin give Yu.
PSA 51:17 Di sakrifice wey Yu wont, na spirit wey dey honbol and dey obey Yu. My God, Yu nor go rijet pesin wey honbol and turn from en sin kom meet Yu.
PSA 51:18 My God, make Yu look Zion with favor kon help am; make Yu ribuild Jerusalem walls again.
PSA 51:19 Den Yu go asept di sakrifice wey dem go offa with betta spirit; di burnt and di full ofrins. Den pipol go offa melu as sakrifice, for yor altar again.
PSA 52:1 David Song For Di Kwaya Leader. E rite am wen Doeg from Edom go meet and tell Saul sey David don go Ahimelek house. Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?
PSA 52:2 Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan. Yor tongue dey kut pipol like razor blade and yu sabi lie well-well.
PSA 52:3 Yu like bad tins pass good ones and yu love lie-lie pass trut.
PSA 52:4 Yu wey dey lie well-well, yu like to distroy odas with yor words!
PSA 52:5 But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.
PSA 52:6 Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey,
PSA 52:7 “Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”
PSA 52:8 But I bi like olive tree wey dey grow well inside God house. I go always trust God love wey nor dey fail.
PSA 52:9 My God, I go praiz yu forever, bikos of di tins wey yu don do. I go always dey trust Yu, bikos pipol wey dey obey Yu, know sey Yu dey good.
PSA 53:1 David Song For Di Kwayamasta Na fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good!
PSA 53:2 God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am.
PSA 53:3 But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all!
PSA 53:4 Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.
PSA 53:5 Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
PSA 53:6 Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
PSA 54:1 David Song For Di Kwayamasta Wen Zif Pipol Go Ripot Am My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi! Make Yu defend mi with yor strent.
PSA 54:2 My God, make Yu listin to my prayers. Make Yu listin to mi as I dey beg.
PSA 54:3 Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God.
PSA 54:4 But na God dey help mi. Na God dey keep my life!
PSA 54:5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem.
PSA 54:6 I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and
PSA 54:7 Yu save mi from my trobols kon help mi defeat my enemies.
PSA 55:1 David Song For Di Kwayamasta My God, listin to my prayer. Nor trowey yor face wen I dey kry for help!
PSA 55:2 Abeg, make Yu listin kon ansa mi, bikos di trobol wey dey face mi, too mush.
PSA 55:3 My enemies dey shaut for mi; dem dey shaut and treaten mi well-well. Dem dey karry wahala kom and dem won kill mi.
PSA 55:4 My heart dey beat for my chest and bikos of deat, I kon dey fear.
PSA 55:5 I just dey fear dey shake anyhow and I nor fit stop to shake.
PSA 55:6 I wish sey I get feada like dove, I for don fly go where I go rest!
PSA 55:7 I go fly go far; go rest for wildaness bikos e dey kwayet.
PSA 55:8 I go kwik run go where I go dey save from dis pipol wey hate mi well-well.
PSA 55:9 So my God, make Yu konfuse and skata dia plans, bikos na wahala and konfushon I dey si for di town.
PSA 55:10 Both for day and nite, dem dey waka on-top di town wall and na wikedness and distroshon full der.
PSA 55:11 Evritin don skata and na so-so to dey treaten and shit pipol, full di town.
PSA 55:12 If to sey na enemy dey laf mi, I for fit bear-am. If to sey na enemies dey make mout for mi, I for fit hide from dem.
PSA 55:13 But na yu my klose friend; di pesin wey I like well-well.
PSA 55:14 Wi don tell each oda awa sekret; wi dey waka togeda among di pipol wey dey God Temple.
PSA 55:15 Make deat distroy my enemies; make di grave swallow dem alive, bikos na wikedness dem dey stay with.
PSA 55:16 But I go koll my God and E go kon save mi.
PSA 55:17 For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.
PSA 55:18 E go diliver and save mi from pipol wey dey plan against mi, even doh dem many well-well.
PSA 55:19 God wey dey rule forever go hear mi kon deal with dem, bikos my enemies nor gri shange from di wiked tins wey dem dey do and dem nor dey fear God.
PSA 55:20 Dem dey attack dia friends and break di promise wey dem make with dem.
PSA 55:21 Dia words dey smooth like butter, but dia heart strong like stone. Dia word smooth well-well like pomade, but na dagger dey under dia tongue!
PSA 55:22 So make una give all una trobol to God, bikos E kare about una. E nor go allow pipol wey dey obey am, draw fall for groun.
PSA 55:23 But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
PSA 56:1 David Song Wen Filistia Pipol Dey Porshu Am My God, make Yu sorry for mi, bikos pipol dey attack mi. My enemies dey attack mi evriday.
PSA 56:2 Pipol wey won si sey I fall, dey always attack mi. True-true many of dem dey fight mi.
PSA 56:3 But even as I dey fear, I still trust Yu.
PSA 56:4 I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear?
PSA 56:5 Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.
PSA 56:6 Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
PSA 56:7 So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape!
PSA 56:8 Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.
PSA 56:9 My enemies go run wen I koll Yu for help, bikos I know sey God dey for my side!
PSA 56:10 I dey praiz God for wetin E don promise. Yes! I go dey praiz am, bikos of en promise.
PSA 56:11 I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear? Wetin ordinary human being go fit do mi?
PSA 56:12 My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.
PSA 56:13 Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.
PSA 57:1 David Prayer Wen E Dey Run From Saul My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.
PSA 57:2 I kry to di Most High; di God wey dey supply evritin wey I wont
PSA 57:3 and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.
PSA 57:4 Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.
PSA 57:5 My God, make Yu raiz pass di sky! Make yor glory shine for evriwhere for di eart.
PSA 57:6 My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.
PSA 57:7 My God, I get hope. Yes! I get hope. So I go sing kon praiz yor name.
PSA 57:8 So, make my heart wake-up! Trumpet and jita, make una wake-up too! Mi mysef go wake-up for morning with song for my mout.
PSA 57:9 I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.
PSA 57:10 Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven. Yor faithfulnes dey rish di kloud.
PSA 57:11 My God, make Yu raiz pass di sky and make yor glory shine kon kover di whole eart.
PSA 58:1 David Song For Di Kwayamasta Una wey dey rule, una dey judge well? Una dey judge di pipol well so?
PSA 58:2 No! Na bad tins una dey plan for una mind and na wahala una dey kause for di whole town.
PSA 58:3 Dem born dis wiked pipol with sin for dia heart; na from dia mama belle dem don start to lie and do as dem like.
PSA 58:4 Dia spit bi like wiked snake own; dem bi like kobra wey nor dey hear word;
PSA 58:5 bikos dem nor won hear di nois wey di pesin wey dey sharm snake, dey make.
PSA 58:6 So my God, make Yu break dia tit! Make Yu skata di lion jaw.
PSA 58:7 Make dem vanish like wota wey dey flow! Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey!
PSA 58:8 Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka! Make dem bi like pikin wey dem just born, wey nor ever si sun before e die!
PSA 58:9 God go swip dem trowey kwik-kwik, even before pot wey dem put for fire, go dry.
PSA 58:10 Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.
PSA 58:11 Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”
PSA 59:1 David Song Wen Saul One Kill-am My God, make Yu save mi from my enemies. Make Yu protet mi from di pipol wey won kill mi.
PSA 59:2 Save mi from pipol wey dey do bad tins and doz wey like wahala well-well.
PSA 59:3 My God, si as dem dey wait for korna to katch mi; wiked and strong men dey wait to katch mi, even doh I nor sin or do bad tin.
PSA 59:4 I nor do anytin bad, yet dem dey wait to attack mi. Make Yu raiz-up kon si wetin dey happen, den help mi!
PSA 59:5 My Oga wey bi kommander for heaven, Israel pipol God, make Yu raiz-up kon ponish doz wiked nashons. Make Yu nor sorry for wiked pipol.
PSA 59:6 Dem dey waka round di town for nite like wiked dogs.
PSA 59:7 Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”
PSA 59:8 But Oga God, dey laf dem. Yu dey laf all dis wiked nashons.
PSA 59:9 Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi! Na Yu God, bi my guide!
PSA 59:10 My God wey love mi go help mi. E go make mi happy, bikos I win my enemies.
PSA 59:11 Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.
PSA 59:12 Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips, make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.
PSA 59:13 Make Yu distroy dem as Yu dey vex! Make Yu distroy dem finish! Den di whole world go know sey God dey reign for Israel.
PSA 59:14 My enemies dey kom out for nite like wiked dog wey dey waka about for street.
PSA 59:15 Dem dey find food to chop and even wen dem si chop, di food nor dey rish dem.
PSA 59:16 But for mi, I go sing about yor pawa. Evry morning, I go sing with joy about yor love wey nor dey fail, bikos na Yu bi my guide; di place where I dey hide wen trobol kom.
PSA 59:17 Na Yu dey give mi strent, so I go sing praiz to Yu. Na Yu dey guide mi; di God wey show mi en love wey nor dey fail.
PSA 60:1 For Di Kwayamasta. Akordin to Shushan-edut style. David prayer to take tish odas. E rite am wen e dey fight with Aram Naharaim and Aram Zobah. Dat na wen Joab turn back kon kill 12,000 sojas from Edom for Salt Valley. My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.
PSA 60:2 Yu shake di eart kon tear am into two. So, make Yu join where divide, bikos di eart don dey fall.
PSA 60:3 Yu dey trit us with strong hand kon make us drink wine wey dey katch us naw.
PSA 60:4 But Yu don give one banner to pipol wey dey fear Yu, so dat dem go dey save wen enemies attack dem.
PSA 60:5 Naw, make Yu save yor pipol wey Yu love. Make Yu ansa kon save us with yor pawa.
PSA 60:6 God don tok from en holy place sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.
PSA 60:7 Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.
PSA 60:8 But Moab wey I dey use as my wosh-hand basin, go bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”
PSA 60:9 So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol?
PSA 60:10 My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?
PSA 60:11 Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help dey yuzles.
PSA 60:12 But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.
PSA 61:1 David Song For Di Kwayamasta My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help!
PSA 61:2 From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.
PSA 61:3 True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies.
PSA 61:4 Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.
PSA 61:5 Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.
PSA 61:6 Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren!
PSA 61:7 Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.
PSA 61:8 Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.
PSA 62:1 David Song For Di Kwayamasta I dey kwayet dey wait, bikos na God dey diliver mi.
PSA 62:2 Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.
PSA 62:3 How long una go dey treaten one man? All of una dey kill pipol and una bi like wall wey don break or fence wey get mark wey go soon fall.
PSA 62:4 Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi for my present, but for dia heart, dem dey curse mi.
PSA 62:5 But my soul and body dey kwayet dey wait for God, bikos na-im dey make my heart strong.
PSA 62:6 Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.
PSA 62:7 My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi for der.
PSA 62:8 My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.
PSA 62:9 Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
PSA 62:10 So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon! Nor put hope for wetin yu tif! If yor money many, make yu nor too happy.
PSA 62:11 God don tok many times sey, “All di pawa for heaven and eart, dey my hand
PSA 62:12 and my love nor dey fail.” True-true, God go pay evribody akordin to wetin dem do.
PSA 63:1 David Song Wen E Dey Judah Wildaness Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.
PSA 63:2 I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory.
PSA 63:3 Yor love wey nor dey fail betta pass life; so I go praiz Yu!
PSA 63:4 I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.
PSA 63:5 Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
PSA 63:6 and for nite, I nor dey fit sleep, bikos I dey tink about how Yu
PSA 63:7 help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow.
PSA 63:8 I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.
PSA 63:9 But distroshon go follow doz wey dey plan to distroy mi. Dem go die go where dead body dey.
PSA 63:10 Na swod go kill dem, den birds and oda animals go chop dia body.
PSA 63:11 But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.
PSA 64:1 David Song For Di Kwayamasta My God, make Yu listin to mi as I dey komplain! Make Yu protet my life from all di wiked attack wey di enemies dey plan.
PSA 64:2 Make Yu hide mi from wiked men plan; di pipol wey dey do evil and bad tins.
PSA 64:3 Dem don sharp dia tongue like swod kon ready to shot dia betta words wey bi like arrows.
PSA 64:4 From where wiked pipol hide put, dem dey shot innocent pipol kon kwik-kwik attack dem and dis wiked pipol, nor dey fear.
PSA 64:5 Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”
PSA 64:6 As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.
PSA 64:7 But God go shot dem; na wons en arrows go wound dem and dem go fall.
PSA 64:8 Na dia own bad word go kill dem. And anybody wey si dem, go shake en head kon sorry for dem.
PSA 64:9 Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.
PSA 64:10 Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.
PSA 65:1 David Song For Di Kwayamasta My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu, bikos yor pipol dey do wetin dem promise.
PSA 65:2 Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.
PSA 65:3 Awa sins too many, so Yu don forget us, bikos wi nor dey hear word.
PSA 65:4 But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.
PSA 65:5 Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.
PSA 65:6 Yu kreate di mountins with yor strent kon show as yor pawa strong rish.
PSA 65:7 Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.
PSA 65:8 Even pipol wey dey far from awa land, dey sopraiz for yor greatness and Yu make doz wey dey stay for east and west, praiz Yu.
PSA 65:9 Yu visit di eart kon make rain fall put, so dat e go dey good kon produce plenty food. Yu make wota full di sea and di land dey bring betta food, bikos Yu don kommand sey na so e go bi.
PSA 65:10 Yu dey wet di dry groun with rain, so dat di soil go soft and seeds go grow well.
PSA 65:11 Yu crown di year with yor good blessing and even where hard pass, still dey produce plenty food.
PSA 65:12 Di grass for wildaness dey fresh and di hill dey shine with joy.
PSA 65:13 Na animals full di fields and na betta food full di valley. Evritin dey sing and shaut for joy!
PSA 66:1 Dis Song Na For Di Kwayamasta Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!
PSA 66:2 Make una sing about di glory wey en name dey bring! Make una tell di world how en glory big rish.
PSA 66:3 Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa!
PSA 66:4 Evritin for eart go woship Yu; dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory as dem dey koll yor name.”
PSA 66:5 Make una kom si wetin God don do; di wonderful mirakles wey E do among en pipol!
PSA 66:6 E turn di Red Sea to dry land and en pipol kon dey happy as dem dey waka pass di dry groun.
PSA 66:7 Na en great pawa E take dey rule forever. E dey si evritin wey di nashons dey do; so make wiked pipol nor dey karry body.
PSA 66:8 Make di whole world bless awa God! Make dem shaut tell evribody about en praiz.
PSA 66:9 Awa life dey en hand and E nor let us fall.
PSA 66:10 My God, Yu don test and make us klean like silva.
PSA 66:11 Before-before, Yu katch us for yor net kon make us sofa well-well.
PSA 66:12 Yu allow men rule us; wi dey pass thru fire and wota, but naw, Yu don bring us kom where dey save.
PSA 66:13 I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;
PSA 66:14 di vow wey I tok with my mout and my lip wen I dey trobol.
PSA 66:15 I go give Yu fat animals as burnt ofrin, plus di smell from ram wey dem sakrifice. I go give Yu melu and goats.
PSA 66:16 Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
PSA 66:17 I kry to am make E help mi kon praiz am with my tongue.
PSA 66:18 If I gada sin for my heart, God nor go ansa or listin to mi.
PSA 66:19 But God dey hear and listin to my prayers.
PSA 66:20 Na God get all di praiz, bikos E nor rijet my prayers and E still dey show mi en love wey nor dey fail!
PSA 67:1 David Song For Di Kwayamasta Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!
PSA 67:2 Den pipol wey dey for di world go know wetin Yu like; all di nashons go know how Yu take diliver yor pipol.
PSA 67:3 My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
PSA 67:4 Make strenjas happy well-well, bikos Yu dey judge pipol matter well and na Yu dey rule di world.
PSA 67:5 My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
PSA 67:6 All di seed wey dem plant dey grow well for di eart, so make di Oga awa God, bless us!
PSA 67:7 Make E bless us, den evritin for di eart go gi-am di honor wey bi en own.
PSA 68:1 For Di Kwayamasta: David Song Make God raiz-up! Make all en enemies skata! Make all di pipol wey hate am, run as dem si am.
PSA 68:2 As breeze dey blow smoke, na so too Yu go drive dem go and as butter dey melt near fire, na so too wiked pipol go die before God.
PSA 68:3 But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.
PSA 68:4 So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!
PSA 68:5 Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.
PSA 68:6 God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war, E dey free prisonas kon make dem prosper. But pipol wey dey sin, dey stay for desert forever.
PSA 68:7 So, my God, wen Yu lead yor pipol go war; wen Yu mash pass di desert,
PSA 68:8 di eart dey shake. Yes! Rain dey fall from heaven before di Oga wey bi Sinai God; di Oga wey bi Israel pipol God.
PSA 68:9 My God, na Yu make rain dey fall for yor pipol land. Wen yor pipol don taya, na Yu dey give dem pawa,
PSA 68:10 bikos Yu dey stay with dem. My God, na yor blessing save doz wey dem dey opress.
PSA 68:11 God tok di word; many wimen spread di good news sey:
PSA 68:12 “Kings and dia sojas dey run!” So Israel wimen kon divide dia propaty.
PSA 68:13 Even pipol wey dey stay for animal house, dey si doves wey get feadas wey dem make with silva and gold wey dey shine.
PSA 68:14 Wen God wey get pawa skata kings, dem dey melt like snow for Mount Zalmon!
PSA 68:15 Mount Bashan high well-well; Bashan mountin get many top.
PSA 68:16 Yu mountin wey get many top, why yu dey jealous di mountin wey God won stay? True-true, God go stay der forever.
PSA 68:17 Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.
PSA 68:18 God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!
PSA 68:19 Na Oga God get all di praiz, bikos na evriday E dey karry awa wahala. Na-im bi di God wey diliver us.
PSA 68:20 Awa Oga na God wey dey diliver; di God wey get pawa and wey fit save us from deat.
PSA 68:21 True-true, God dey nak en enemies head; E dey nak doz wey dey always do wiked tins.
PSA 68:22 God sey, “I go koll dem back from Bashan, I go bring dem kom back from under di sea,
PSA 68:23 so dat una go waka on-top dia blood and una dogs go chop una enemies dead body.”
PSA 68:24 My God, dem dey si as Yu take dey waka; true-true, my King wey dey mash kom with glory, pipol dey si as E dey kom.
PSA 68:25 Pipol wey dey sing, dey waka for en front; while di odas dey play dia instrument dey follow for back and yong girls dey play dia sheke-sheke.
PSA 68:26 So, God pipol wey gada togeda, make una praiz di Oga una God!
PSA 68:27 Benjamin tribe wey small pass, na dem dey front, den Judah leaders with dia group and di leaders for Zebulun and Naftali tribe, follow for back.
PSA 68:28 But God don kommand sey una go get pawa well-well. So, my God wey help us wen wi nor even know, make Yu show yor pawa
PSA 68:29 as Yu kom out from yor temple for Jerusalem, bikos kings dey kom give Yu respet for der.
PSA 68:30 Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota and di nashons wey dey follow am, until dem go honbol demsef kon offa gold and silva give Yu. Make Yu skata doz pipol wey like war.
PSA 68:31 Egypt and Ethiopia pipol go dey ready to kom serve God on dia own; nobody go force dem kom.
PSA 68:32 So, make all di kingdom for di world sing praiz God! Make una sing praiz dis God,
PSA 68:33 bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.
PSA 68:34 Make una tok about di pawa wey God get; en mighty pawa wey dey save Israel and di pawa wey E show from di sky!
PSA 68:35 God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!
PSA 69:1 David Song For Di Kwayamasta My God, make Yu save mi, bikos di wota don almost kover mi.
PSA 69:2 I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.
PSA 69:3 I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.
PSA 69:4 Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!
PSA 69:5 My God Yu know all di sins wey I kommit for sekret; bikos my sins nor fit hide from Yu.
PSA 69:6 My God and king wey get pawa; nor let shame katch doz wey trust Yu! Bikos of mi, nor let disgrace follow doz wey dey find Yu.
PSA 69:7 I don sofa well-well, bikos of Yu. Na disgrace dem rite full my face
PSA 69:8 My own brodas dey trit mi like strenja; dem dey do like sey I kom from anoda kountry.
PSA 69:9 True-true, di love wey I get for yor house dey shark mi; so I dey bear di curse wey dem dey curse mi.
PSA 69:10 I dey kry and I nor gri chop food and na dis make odas dey curse mi.
PSA 69:11 I wear sak klot and dem dey laf mi.
PSA 69:12 Doz wey dey sidan for di town gate dey tok about mi and pipol wey don drink, dey sing and laf mi with dia song.
PSA 69:13 So my God, make Yu hear my prayers kon favor mi and bikos of yor great love, make Yu ansa and diliver mi!
PSA 69:14 Make Yu save mi from di mud! Nor let mi sink! Diliver mi from pipol wey hate mi and from di deep wota!
PSA 69:15 Abeg! Make Yu nor let di wota karry mi go! Nor let di wota swallow mi! Make Yu nor let mi die inside di pit!
PSA 69:16 My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!
PSA 69:17 Nor leave yor savant, bikos I dey trobol, but make Yu ansa mi naw-naw!
PSA 69:18 Make Yu kom near and save mi! Make Yu save mi from my enemies!
PSA 69:19 Yu know how dem dey curse, disgrace and do mi anyhow and Yu dey si evritin wey my enemies dey do.
PSA 69:20 Dia curse dey pain and e dey make my heart kut; I dey look for who go tell mi sorry, but I nor si. I dey find who go konfort mi, but I still nor si anybody.
PSA 69:21 Dem dey put poizin for my food kon give mi bad wine make I drink.
PSA 69:22 So, make dia food tabol bi trap for dem! Make e bi trap for all doz dia friends!
PSA 69:23 Make dia eyes blind and make dem dey shake with fear!
PSA 69:24 Make Yu pour yor judgement for dia head and make yor strong vexnashon distroy dem!
PSA 69:25 Make dia house turn where pipol go dey trow dirty put and make all dia pipol die finish,
PSA 69:26 bikos dem don curse di pesin wey bi yor own. Wen Yu ponish pipol wey bi yor own, na dis wiked pipol dey karry di matter go evriwhere.
PSA 69:27 So, make Yu hold dem, bikos of all dia sins! Make Yu nor sorry for dem at-all!
PSA 69:28 Make Yu remove dia names from yor book wey get life! Make Yu nor rite dia names join pipol wey dey fear God!
PSA 69:29 Dem dey opress and sofa mi! So my God, make Yu diliver and protet mi!
PSA 69:30 I go sing and praiz God name! I go dey praiz am as I dey tank am!
PSA 69:31 Dat one go sweet God pass ordinary melu or oda animals wey get horn.
PSA 69:32 So make pipol wey dem dey opress, happy, bikos God go enkourage doz wey dey obey am.
PSA 69:33 God dey listin to doz wey nor get help and E nor go forget en pipol wey dem dey ponish.
PSA 69:34 So make di heavens and eart praiz am, plus di sea and evritin wey dey swim inside am!
PSA 69:35 Bikos God go diliver Zion kon ribuild Judah town and en pipol go stay der again kon take-ova Zion.
PSA 69:36 En savant shidren-shidren go inherit am and pipol wey dey loyal to am go stay der.
PSA 70:1 David Song For Di Kwayamasta My God, make Yu kwik kom save mi! Hurry kom help mi!
PSA 70:2 Make shame and disgrace follow pipol wey won kill mi!
PSA 70:3 Pipol wey dey laf dey sey, “Aha! Aha!” Make Yu porshu dem go back kon disgrace dem!
PSA 70:4 All di pipol wey dey find Yu, make dem dey happy with joy, bikos of Yu! Pipol wey love to si sey Yu diliver dem, make dem always dey sey, “Make all di praiz bi God own!”
PSA 70:5 Dem don opress mi and I nor get anytin! Abeg my God, make Yu kwik kom save mi, bikos na Yu bi my helpa and di Pesin wey dey diliver mi! So make Yu kwik kom!
PSA 71:1 My God, I don run kom meet Yu make Yu protet mi; so nor let dem disgrace mi.
PSA 71:2 Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite. Make Yu listin and diliver mi.
PSA 71:3 Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put. Give kommand make dem save mi, bikos Yu bi my rock and di place where I dey hide put.
PSA 71:4 My God, save mi from wiked pipol pawa and from doz wey dey opress mi,
PSA 71:5 bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin, I don dey trust Yu kom rish naw.
PSA 71:6 Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!
PSA 71:7 My life na ezample to many pipol, bikos na Yu bi my strent and proteshon.
PSA 71:8 Dat na why I nor fit stop to praiz Yu and I go dey tok about yor glory evriday.
PSA 71:9 Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi. Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.
PSA 71:10 My enemies dey gossip mi. Dem dey plan how dem go take kill mi.
PSA 71:11 Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”
PSA 71:12 So, my God, make Yu nor leave mi, but make Yu hurry kom save mi.
PSA 71:13 Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi. Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.
PSA 71:14 But for mi, I go always dey wait for yor help and I go dey praiz Yu more and more.
PSA 71:15 I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.
PSA 71:16 My God wey get pawa, I go praiz Yu bikos of all di great tins wey Yu don do. I go tell evribody sey na only Yu dey do good.
PSA 71:17 My God, na from wen I bi small pikin, Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey Yu don do.
PSA 71:18 Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.
PSA 71:19 My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?
PSA 71:20 Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.
PSA 71:21 I know sey Yu go karry mi put for where dem go for honor mi well, so make Yu turn kon konfort mi.
PSA 71:22 Den I go praiz Yu with harp, bikos Yu dey faithful to yor promise. My God, I go use jita take sing praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.
PSA 71:23 I go shaut for joy kon sing with praiz, bikos Yu don save mi
PSA 71:24 and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works, bikos evribody wey dey try to kill mi, Yu don disgrace and make shame katch dem.
PSA 72:1 David Prayer For Solomon My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!
PSA 72:2 Den e go judge yor pipol and doz wey dem dey opress, well.
PSA 72:3 Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol and di hills go tok about korrect judgement.
PSA 72:4 E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.
PSA 72:5 As long as di sun and moon dey di sky, pipol go always dey fear Yu from one generashon go rish anoda.
PSA 72:6 Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall on-top grass wey dem kut; e go bi like rain wey dey wota di groun.
PSA 72:7 All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.
PSA 72:8 Make di king rule from sea go rish sea and from Eufrates River go rish di end for di eart.
PSA 72:9 Desert go bow before am; en enemies go fall for groun for en front.
PSA 72:10 Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
PSA 72:11 All di kings go bow for am and all di nashons go serve am.
PSA 72:12 Di King go save poor pipol wen dem kry kom meet am kon help doz wey dem dey opress and doz wey nor get who go fight for dem.
PSA 72:13 E go pity for doz wey dey weak and poor kon save dem.
PSA 72:14 Bikos dia life dey important to am, e go save dem from pipol wey dey opress and kause wahala for dem.
PSA 72:15 Di king go live forever! Dem go dey gi-am gold from Sheba and di pipol go always dey pray and bless am evriday.
PSA 72:16 Food go many for di land and seeds go even dey grow well on-top mountins. Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon and make pipol for di land dey grow well like betta grass for di field.
PSA 72:17 Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.
PSA 72:18 Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.
PSA 72:19 Make una praiz en name wey get glory forever! Make en glory dey di whole eart. Amen!
PSA 72:20 David wey bi Jesse pikin, na here en prayers for end.
PSA 73:1 Asaf Song True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.
PSA 73:2 But for mi, my heart almost fail mi and my faith don nearly vanish,
PSA 73:3 bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.
PSA 73:4 E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong.
PSA 73:5 Dem nor dey face trobol like oda pipol or si wahala like evry oda pesin.
PSA 73:6 Dem wear pride like shain for neck kon wear yanga like belt for waist.
PSA 73:7 Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about.
PSA 73:8 Evritin wey dem dey do and tok, na only about wiked tins and as dem dey proud, evritin wey dem wont, na to kill oda pipol.
PSA 73:9 Dem dey boast like sey dem dey stay heaven and dey bihave like sey na dem get di world,
PSA 73:10 so even God pipol dey bilive evritin wey dis wiked pipol dey tok.
PSA 73:11 Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”
PSA 73:12 Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty.
PSA 73:13 So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!
PSA 73:14 Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”
PSA 73:15 If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu.
PSA 73:16 So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more!
PSA 73:17 Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol.
PSA 73:18 True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.
PSA 73:19 Na wons God go take distroy and trowey dem down with fear.
PSA 73:20 So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break.
PSA 73:21 Yes, my heart dey bitter and I dey feel pain for inside my body.
PSA 73:22 I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.
PSA 73:23 Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.
PSA 73:24 Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.
PSA 73:25 Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.
PSA 73:26 My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.
PSA 73:27 So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am.
PSA 73:28 But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.
PSA 74:1 Asaf Song My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
PSA 74:2 Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.
PSA 74:3 Make Yu waka round di town wey dem skata; den Yu go si as di enemies distroy yor temple.
PSA 74:4 Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.” Na der dem for stand dia war flag.
PSA 74:5 Dem dey use dia axe like doz wey dey kut wood for bush.
PSA 74:6 Dem use axe and knife take skata evritin wey dem karve
PSA 74:7 kon burn yor temple rish groun. Yes, dem distroy di place wey dey ansa yor name.
PSA 74:8 Den dem kon dey boast dey sey, “Make wi distroy evritin!” So dem burn evriwhere wey wi for dey woship God.
PSA 74:9 Naw, wi nor dey si yor mirakles again. All di profets don die and nobody fit tell us wen dis wahala go end.
PSA 74:10 So God, na how long e go take before Yu go stop awa enemies wey dey curse us? Yu go let dem take yor name make yeye forever?
PSA 74:11 Wetin make Yu nor won use yor strong rite hand against dem? Make Yu kom distroy dem finish.
PSA 74:12 But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time and Yu dey save us for dis world.
PSA 74:13 Yu divide di sea with yor pawa kon kill di monsta wey dey der.
PSA 74:14 Yu skata di wota juju head kon allow animals for desert chop am.
PSA 74:15 Just as Yu get pawa to make wota and sea flow, na so too, Yu fit dry river wey nor suppose dry.
PSA 74:16 Na Yu get both day and nite; na Yu still make di moon and di sun.
PSA 74:17 Yu measure where di eart go rish kon make both dry and rainin sizin.
PSA 74:18 My God, si as di enemies dey curse Yu. Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name.
PSA 74:19 Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol. Yor pipol wey dey sofa, make Yu nor forget dem forever.
PSA 74:20 Make Yu remember yor kovenant, bikos na darkness and trobol full di land!
PSA 74:21 Make Yu nor let dem disgrace pipol wey dey sofa. Instead, make Yu let poor pipol and doz wey dem dey opress, praiz yor name.
PSA 74:22 My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.
PSA 74:23 Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok or how dem dey shaut anyhow.
PSA 75:1 Asaf Song For Di Kwayamasta My God, wi tank Yu! Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us and pipol for evriwhere dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do.
PSA 75:2 God sey, “Wen di time wey I choose don rish, I go judge pipol.
PSA 75:3 Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon.
PSA 75:4 I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!
PSA 75:5 Make una nor tink sey una don win di fight or karry body up wen una dey tok.’ ”
PSA 75:6 Viktory nor dey kom from east or west or from di wildaness,
PSA 75:7 bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.
PSA 75:8 One cup wey full with wine wey dem mix with spice, dey for God hand and E pour am for di world. True-true, all di wiked pipol for di world go drink from am till e finish.
PSA 75:9 But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do; I go sing and praiz Jakob God!
PSA 75:10 God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”
PSA 76:1 Asaf Song For Di Kwayamasta God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.
PSA 76:2 Na Jerusalem E dey stay and na Mount Zion bi en house.
PSA 76:3 Na der E for break di enemies wiked arrow, dia guide, swod and all di tins wey dem take dey fight.
PSA 76:4 En glory and majesty dey shine as E dey kom from di mountin where E for kill en enemies.
PSA 76:5 Awa strong enemies don skata. Dem don sleep kon die go like dat, so nobody go fit fight us again.
PSA 76:6 My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath, all yor enemies horse and shariot dey fall die.
PSA 76:7 No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
PSA 76:8 Na from heaven Yu dey judge yor enemies; di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.
PSA 76:9 My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins kon save doz wey dem dey opress for dis world.
PSA 76:10 True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
PSA 76:11 So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
PSA 76:12 E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.
PSA 77:1 Asaf Song For Di kwayamasta I shaut and kry to my God; yes I shaut and E hear mi!
PSA 77:2 Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.
PSA 77:3 Wen ever I tink of God, na kry I always dey kry make E kom help mi.
PSA 77:4 Yu nor dey let mi sleep and I too dey weak to pray!
PSA 77:5 I bin dey tink of di good days before-before,
PSA 77:6 wen betta song with joy full my nite. But naw, I dey look my life kon dey tink and si how e dey difren.
PSA 77:7 So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?
PSA 77:8 En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?
PSA 77:9 God don forget to dey sorry for pesin? E don klose di door to pipol wey dey kom meet am for help?
PSA 77:10 So I kon sey, “Na mi kause am! Na mi let God turn en hand against mi”
PSA 77:11 But my Oga God, I remember evritin wey Yu don do. I remember all di wonderful tins wey Yu do before.
PSA 77:12 Dem always dey my mind and I nor fit stop to dey tink about di mighty tins wey Yu do.
PSA 77:13 My God, yor ways dey holy. E get any god wey get pawa like Yu?
PSA 77:14 Na Yu bi God wey dey do great wonders! Yu dey show yor great pawa among di nashons.
PSA 77:15 With yor hand, Yu save yor pipol wey bi Jakob and Josef shidren-shidren.
PSA 77:16 My God, wen di Red Sea si Yu, di wota kon dey fear and di sea shake rish bottom.
PSA 77:17 Rain fall kom down from di kloud and tonda nois full di sky, den yor arrow with lite kon dey shine.
PSA 77:18 Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.
PSA 77:19 Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.
PSA 77:20 Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.
PSA 78:1 Asaf Song My pipol, make una listin to wetin I dey tok. Make una open una ear, so dat una go hear wetin I dey tell una,
PSA 78:2 bikos na parabol I go take tok to una. I go tish una about some tins wey don happen before;
PSA 78:3 story wey awa grand-grand papa dem tell us.
PSA 78:4 Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.
PSA 78:5 E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel, wetin dem go do. E still kommand awa grand-grand papa sey make dem tish di laws to dia shidren,
PSA 78:6 so dat di next generashon go know; even di shidren wey dem neva born and dis ones too go tish dia own shidren.
PSA 78:7 So evry generashon go get hope and trust God and dem nor go forget en great mirakles, but dem go obey en kommand.
PSA 78:8 Dem nor go bi like dia grand-grand papa wey sturbon; pipol wey nor gri obey, listin or give dia heart to God.
PSA 78:9 Efraim sojas, even doh dem get bow and arrow, wen war start, dem go run,
PSA 78:10 bikos dem nor gri keep God kovenant or obey en kommandment.
PSA 78:11 Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem,
PSA 78:12 di mirakles wey E do for dia grand-grand papa for Zoan wey dey for Egypt.
PSA 78:13 For der, E divide di sea kon take dem pass as di wota stand up like wall!
PSA 78:14 E dey lead dem with kloud for day and pila wey get fire for nite.
PSA 78:15 E tear rock open kon give dem wota drink for wildaness!
PSA 78:16 E make wota kom out from di rock and e kon dey flow like river!
PSA 78:17 Yet dem still dey sin against am; dey disobey di Most High for di desert.
PSA 78:18 Dem dey test God with sturbones for dia heart kon dey tok di kind food wey dem won chop.
PSA 78:19 Dem even tok against God ensef wen dem sey, “God nor fit give us food for di wildaness.
PSA 78:20 Yes! E fit nak rock make wota kom out, but E nor fit give en pipol bread and meat.”
PSA 78:21 Wen God hear dem, E vex well-well. Di fire from en vexnashon kon dey against en pipol. Yes! En vexnashon kon strong well-well,
PSA 78:22 bikos dem nor gri bilive God or trust sey E go kare for dem.
PSA 78:23 But E kommand di sky make e open, den E open di doors for heaven.
PSA 78:24 E send manna kom down so dat en pipol go si food chop; E give dem bread from heaven.
PSA 78:25 Dem chop food wey angels dey chop and God give dem enough to chop.
PSA 78:26 God release di east wind for heaven kon guide di sout wind with en pawa.
PSA 78:27 E send meat like dust go give dem kon still give dem birds wey plenty like san-san wey dey wotaside!
PSA 78:28 E make di birds dey fall for evriwhere for dia kamp and for dia house
PSA 78:29 and di pipol chop beleful. E give dem wetin dem ask for.
PSA 78:30 But before dem even beleful, as di meat still dey dia mout,
PSA 78:31 God kon dey vex for dem and E kill all dia strong-strong men. E kill Israel yong men wey fine pass.
PSA 78:32 But even as all dis tins dey happen, di pipol still dey sin. With all dis mirakles, dem nor gri trust am.
PSA 78:33 So E kon make dem die with disgrace and dia years kon end with shame.
PSA 78:34 Wen God dey kill dem, dem kon dey beg make E sorry for dem. Dem turn to God kon take am sirious.
PSA 78:35 Den dem remember sey na God bi dia rock; sey na di Most High God save dem.
PSA 78:36 But dem dey lie give God kon dey tok anyhow.
PSA 78:37 Dia heart nor dey loyal to God and dem nor gri keep en kovenant.
PSA 78:38 Yet, God sorry for dem kon forgive dem dia sins and E nor distroy all of dem. So, E nor dey too vex for dem or show en vexnashon,
PSA 78:39 bikos E remember sey na ordinary human being dem bi. Dem go just die go like breeze wey nor dey kom back again.
PSA 78:40 Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.
PSA 78:41 Dem always dey test and shalenge God. Dem dey make di Holy One for Israel dey vex.
PSA 78:42 Dem nor remember en pawa and how E save dem from dia enemies.
PSA 78:43 Dem nor remember all di mirakles wey E do for Egypt; di wonders wey E do for Zoan field,
PSA 78:44 bikos E turn Egypt river to blood, so dat nobody go fit drink di wota.
PSA 78:45 E send many fly kon attack dem and many frog skata dia land.
PSA 78:46 E allow katapiller chop dia plants and lokust chop all dia seed.
PSA 78:47 E distroy dia grape vine with big-big stones kon skata dia sykamore-fig tree.
PSA 78:48 E kill and distroy dia animals with big-big stone and strong tonda.
PSA 78:49 E show dem en great vexnashon and anga. E send angels wey dey distroy tins go meet dem.
PSA 78:50 E turn en vexnashon face dem. E nor sorry for Egypt pipol life, but E use strong wahala take distroy dem.
PSA 78:51 E kill all di first sons for Egypt family; all di first sons wey Egypt pipol born.
PSA 78:52 But E lead en own pipol kom out like many sheep kon guide dem pass di wildaness.
PSA 78:53 E guide and keep dem as dem dey go; but di sea kill dia enemies.
PSA 78:54 E bring dem kom di borda for en holy land; di hill lands wey E don win for dem.
PSA 78:55 E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.
PSA 78:56 But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God and dem nor gri obey en laws.
PSA 78:57 Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama. Yu nor fit put hope on dem, bikos dem bi like bow wey don spoil.
PSA 78:58 Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods; dem really make God jealous with dia juju.
PSA 78:59 Wen God hear dem, E kon dey vex and E really rijet Israel pipol.
PSA 78:60 Den E leave en place for Shiloh, di Tabanako where E bin dey stay with en pipol.
PSA 78:61 E allow enemies karry en Kovenant Box kon give dem en glory.
PSA 78:62 E give en pipol to enemies make dem kill dem with swod, bikos E dey vex well-well with di pipol wey E love well-well.
PSA 78:63 Na fire kill dia yong men and dia yong wimen die even before dem sing dia wedding song.
PSA 78:64 Dem kill dia priests and wimen wey dia husband don die, nor fit mourn for dem.
PSA 78:65 Den God raiz-up like sey E just dey wake from sleep; like strong soja wey en eye just klear from drink.
PSA 78:66 E skata en enemies kon disgrace dem forever.
PSA 78:67 But E rijet Josef shidren-shidren and E nor gri support Efraim tribe again.
PSA 78:68 Instead, E choose Judah tribe and Mount Zion wey E love.
PSA 78:69 E build temple wey high like heaven kon strong like di eart, den E put am for der.
PSA 78:70 E choose David en savant, wen E koll am from where e for dey kare for sheep.
PSA 78:71 E take David from where e for dey kare for animals kon make am leader among Jakob shidren-shidren, wey bi Israel God own.
PSA 78:72 E kare for dem with betta mind kon save dem with en strong hand.
PSA 79:1 Asaf Song My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.
PSA 79:2 Dem don kill yor savants kon leave dia body for groun make bird chop dem. Doz wey dey fear Yu, dia flesh don turn food for wild animals.
PSA 79:3 Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem and nobody remain wey go beri doz wey dem kill.
PSA 79:4 Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us, dey take us make yeye.
PSA 79:5 My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?
PSA 79:6 Make Yu pour yor vexnashon for di nashons wey nor dey respet Yu; di kingdoms wey nor dey koll yor name,
PSA 79:7 bikos dem don finish yor pipol Israel kon turn di land to dirty and empty wildaness.
PSA 79:8 Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us and bikos Yu dey sorry for pipol, make Yu kwik-kwik kom ansa us, bikos e remain small make wi die finish.
PSA 79:9 My God wey dey save us, make Yu kom help us! Make Yu forgive us, bikos of di glory wey dey yor name.
PSA 79:10 Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey, “Where dia God dey?” Make Yu revensh dis pipol, bikos dem don kill yor savants finish.
PSA 79:11 Make Yu listin to di prisonas kry. Make Yu show yor great pawa kon save doz wey pipol sey dem must die.
PSA 79:12 My God, make Yu pay awa neighbours seven times for di mout wey dem don take boast for Yu.
PSA 79:13 Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.
PSA 80:1 Asaf Song For Di Kwayamasta Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine
PSA 80:2 to Efraim, Benjamin and Manasseh pipol. Make Yu show yor mighty pawa, den kom save us!
PSA 80:3 My God, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
PSA 80:4 My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?
PSA 80:5 Yu don make us dey chop sorrow like food kon drink tears wey full bucket.
PSA 80:6 Yu don give oda pipol rizin to dey laf us and naw, awa enemies don take us dey do yeye.
PSA 80:7 My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
PSA 80:8 Yu take us from Egypt like grape fruit, den Yu porshu di wiked nashons kon give us dia land.
PSA 80:9 Yu klear di groun for us and wi stay der kon many for di land.
PSA 80:10 Awa shadow dey kover di mountins; awa branches dey kover di mighty cedars.
PSA 80:11 Before-before, wi spread go west for Mediterranean Sea and Eufrates River.
PSA 80:12 But naw, wetin make Yu break awa walls so dat evribody wey dey pass go fit tif awa fruit?
PSA 80:13 Even wild animals from bush dey kom chop dem too.
PSA 80:14 Awa God, di Warrior wey nobody dey si, wi dey beg make Yu kom back. Make Yu from heaven look kon si di wahala wey wi dey face. Make Yu kare for dis grape tree
PSA 80:15 wey Yu plant by yorsef; bikos na Yu raiz dis pikin up by yorsef.
PSA 80:16 Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.
PSA 80:17 Make Yu support di ones wey Yu choose; di ones wey Yu raiz for yorsef!
PSA 80:18 Den wi nor go turn from Yu. Make Yu bring us back and wi go pray to Yu!
PSA 80:19 Awa God, di warrior wey nobody dey si, make Yu give us life again! Make Yu just smile for us and wi go dey save!
PSA 81:1 Asaf Song For Di Kwayamasta Make wi sing praiz God wey bi awa strent. Make wi sing praiz Jakob God.
PSA 81:2 Make una sing and play sheke-sheke. Make una use jita and harp play sweet music.
PSA 81:3 Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!
PSA 81:4 Bikos dis na wetin dem rite for Israel law and na wetin Jakob God kommand.
PSA 81:5 E make dis law for Israel pipol wen E attack Egypt land just to free us. Den I hear one vois wey I nor know dey sey,
PSA 81:6 “Si, I don take di load komot from una shoulder; I don free una from di heavy work wey una dey do.
PSA 81:7 Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una; I ansa with strong tonda kon test una faith wen wota nor dey to drink for Meribah.
PSA 81:8 My pipol make una listin to mi as I dey warn una! Israel pipol, make una obey mi!
PSA 81:9 Una must nor serve anoda god; una must nor bow before any oda god.
PSA 81:10 Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land. Make una open una mout wide and I go pak good tins full am.
PSA 81:11 But my pipol nor gri listin. Israel pipol nor wont make I dey with dem.
PSA 81:12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.
PSA 81:13 How I wish my pipol go gri listin to mi! How I wish sey Israel pipol go follow mi kon do as I tell dem!
PSA 81:14 Den I for fit kwik distroy dia enemies! My hand for kwik tosh doz wey dey worry dem!
PSA 81:15 Make pipol wey hate God, fear as dem si am; make disgrace follow dem forever.
PSA 81:16 But I go give Israel pipol betta food chop; I go make una beleful with betta honey wey dey flow kom out from di rock.”
PSA 82:1 Asaf Song God stand for where en pipol gada put and E from der dey judge di oda gods
PSA 82:2 sey, “Na how long una go dey judge like dis kon dey favor wiked pipol?
PSA 82:3 Poor pipol and doz wey nor get papa, make una judge dia kase well! Make una free poor pipol and doz wey dem dey opress.
PSA 82:4 Poor pipol and doz wey nor get help, make una save dem from wiked pipol!
PSA 82:5 But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.
PSA 82:6 I bin sey, ‘Una bi gods; bikos una bi di Most High God shidren.’
PSA 82:7 But naw, una go die like ordinary human being kon fall like evry oda leader.”
PSA 82:8 So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.
PSA 83:1 Asaf Song My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!
PSA 83:2 Yu nor si di nois wey yor enemies dey make? Yu nor dey si sey yor sturbon enemies dey make mout anyhow?
PSA 83:3 Dem dey plan against yor pipol and dem won wound di ones wey Yu love.
PSA 83:4 Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”
PSA 83:5 All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.
PSA 83:6 Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;
PSA 83:7 Gebal, Ammon and Amalek pipol with doz from Filistia and Tyre.
PSA 83:8 Assyria pipol don join dem too with Lot shidren-shidren.
PSA 83:9 So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River, na so too Yu go do dem.
PSA 83:10 Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.
PSA 83:11 Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb. Make all di prince die like Zebah and Zalmunna
PSA 83:12 wey bin sey, “Make wi take dis land wey bi God own!”
PSA 83:13 My God, make Yu skata dem like leaf and san-san wey breeze dey blow!
PSA 83:14 As fire dey burn forest and smoke dey make mountin burn,
PSA 83:15 na so too Yu go take porshu dem with yor strong tonda kon make dem fear.
PSA 83:16 My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.
PSA 83:17 Make shame and fear follow dem forever and make dem die with disgrace.
PSA 83:18 Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.
PSA 84:1 Korah Shidren Song For Di Kwayamasta My Oga God wey dey rule ova evritin, make Yu si as di place where Yu dey stay, fine rish!
PSA 84:2 I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.
PSA 84:3 Even birds get house for der and sparo bird still build dia nest for where dem go fit protet dia shidren near yor altar. My Oga wey dey rule ova evritin, my king and my God.
PSA 84:4 Pipol wey dey stay and always praiz God for en temple, make una si as dia blessing big rish!
PSA 84:5 Pipol wey get pawa thru Yu, si as dia blessing big rish too. Dem like to always go yor temple!
PSA 84:6 As dem dey pass thru Baka Valley, Yu dey provide wota for dem, bikos Yu make rain fall full der.
PSA 84:7 Yu dey provide for dem as dem dey travel go di temple and each of dem dey kom meet Yu for Zion.
PSA 84:8 My Oga! Di God wey get pawa! Make Yu hear my prayers! Jakob God, make Yu listin to mi!
PSA 84:9 My God, make Yu favor di king wey dey guide us! Make Yu favor di one wey Yu anoint.
PSA 84:10 Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.
PSA 84:11 Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
PSA 84:12 My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu si di blessing wey dey follow doz wey trust Yu.
PSA 85:1 Korah Shidren Song For Di Kwayamasta My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
PSA 85:2 Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins.
PSA 85:3 Yu nor dey vex for dem again and Yu nor show dem yor vexnashon.
PSA 85:4 My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us!
PSA 85:5 Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?
PSA 85:6 Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu?
PSA 85:7 My God, make Yu show us yor loyal love! Pour yor salvashon for awa head!
PSA 85:8 I go listin to wetin Oga God tok, bikos E go make peace with en pipol; doz wey dey obey am, so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways.
PSA 85:9 True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again.
PSA 85:10 Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.
PSA 85:11 Trut dey kom out from di world and raitiousness dey smile kom down from heaven.
PSA 85:12 Yes, God dey pour en blessings kom down, so awa land go produce betta-betta food again.
PSA 85:13 Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass.
PSA 86:1 David Prayer My God, make Yu hear my prayer; make Yu ansa and help mi, bikos pipol dey opress mi.
PSA 86:2 Make Yu protet and save mi, bikos na only Yu I dey serve and trust and na Yu bi my God.
PSA 86:3 Make Yu sorry for mi, my Oga God, bikos I dey always koll yor name.
PSA 86:4 My God, make Yu make mi happy, bikos I don give mysef to Yu.
PSA 86:5 Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.
PSA 86:6 So my God, make Yu listin well-well to my prayers; make Yu kwik-kwik hear mi as I dey kry for help.
PSA 86:7 I go koll Yu wen ever I dey trobol and Yu go ansa mi.
PSA 86:8 My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!
PSA 86:9 Oga God, all di nashons wey Yu make, go kom bow down for Yu and dem go praiz yor holy name,
PSA 86:10 bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,
PSA 86:11 so make Yu tish mi yor ways, so dat I go live my life as Yu wont am! Make Yu give mi pure heart, so dat I go always dey honor Yu.
PSA 86:12 My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart, I go give glory to yor name forever,
PSA 86:13 bikos di love wey Yu get for mi, big well-well and Yu don save mi from deat.
PSA 86:14 My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi. Yu nor mean anytin to dem!
PSA 86:15 But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol; Yu nor dey kwik vex and Yu dey show yor faithfulnes and great love wey nor dey fail.
PSA 86:16 Make Yu turn face mi kon sorry for mi! Make Yu give yor pawa to yor savant, den diliver pipol wey dey obey Yu.
PSA 86:17 Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi. Den shame go katch di pipol wey hate mi, bikos Yu wey bi my God, don help and konfort mi.
PSA 87:1 Korah Shidren Song Di town wey God build by ensef, dey for di holy mountin.
PSA 87:2 God love Jerusalem pass any oda town for Israel.
PSA 87:3 Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem wey bi God town!
PSA 87:4 I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem!
PSA 87:5 But for Jerusalem real pipol, odas go sey, “Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.” And di Most High God go bless di town by ensef.
PSA 87:6 Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey, “Dem born dis ones sef for Jerusalem.”
PSA 87:7 So di pipol go blow trumpet kon sing sey, “Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”
PSA 88:1 Korah Shidren Song For Di Kwayamasta My Oga God wey dey save mi. For day time, I dey kry give Yu and I still dey pray to Yu for nite.
PSA 88:2 Abeg, make Yu hear my prayer; make Yu listin to mi as I dey kry,
PSA 88:3 bikos na so-so trobol full my life and deat don near mi well-well.
PSA 88:4 I don already bi like pesin wey don die; like strong man wey nor get pawa again.
PSA 88:5 I bi like who dey among dead body and I sleep like sey I dey grave. Yu don forget mi and Yu nor kare for mi again.
PSA 88:6 Yu don trow mi enter deep pit kon keep mi for di place wey dark well-well.
PSA 88:7 Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
PSA 88:8 Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot.
PSA 88:9 My own tears don blind my eyes. My God, evriday I dey beg make Yu kom help mi; I lift my hand to Yu make Yu sorry for mi.
PSA 88:10 All di wonderful tins wey Yu dey do nor mean anytin to pipol wey don die. Abi dead body go fit raiz-up kon praiz Yu?
PSA 88:11 Pipol wey dey grave go fit tok about yor love wey nor dey fail? For where dem dey naw, dem go fit tok about how Yu good rish?
PSA 88:12 Darkness go fit tok about di wonderful tins wey Yu do? Dead body go fit tok about di good-good tins wey Yu dey do?
PSA 88:13 My God, I dey kry give Yu and I go kontinue to beg Yu evriday by day.
PSA 88:14 So, my God, wetin make Yu rijet mi? Wetin make Yu turn yor face from mi?
PSA 88:15 Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
PSA 88:16 Di way Yu dey vex, dey make mi sopraiz. Yes! Yor vexnashon don distroy mi finish.
PSA 88:17 Evriday, pipol gada round mi like wota kon join togeda dey opress mi.
PSA 88:18 Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
PSA 89:1 Etan Song I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish.
PSA 89:2 Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens.
PSA 89:3 God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose. I don promise am sey:
PSA 89:4 ‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ”
PSA 89:5 So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.
PSA 89:6 My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God?
PSA 89:7 Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.
PSA 89:8 My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.
PSA 89:9 Na Yu dey rule di sea and kontrol dia waves.
PSA 89:10 Yu distroy and kill Rahab and Yu skata all yor enemies with yor mighty hand.
PSA 89:11 Na Yu get di heavens and di eart; evritin wey dey di eart na yor own, bikos na Yu kreate all of dem.
PSA 89:12 Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name.
PSA 89:13 Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well! Wons Yu raiz yor rite hand wey get pawa, Yu dey always dey win.
PSA 89:14 Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.
PSA 89:15 Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.
PSA 89:16 Dem dey happy evriday bikos of di wonderful tins wey Yu dey do and yor raitiousness dey save dem.
PSA 89:17 Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong and bikos Yu favor us, wi dey always win.
PSA 89:18 Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.
PSA 89:19 Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king.
PSA 89:20 I don si my savant David and I don anoint am with my holy oil.
PSA 89:21 I go support am with my hand and with my hand wey get pawa, I go make am strong.
PSA 89:22 En enemies nor go fit win am and wiked pipol pawa nor go fit opress am.
PSA 89:23 I go distroy pipol wey dey tok against am kon kill doz wey hate am.
PSA 89:24 My goodness and love wey nor dey fail, go dey with am and with my authority, e go grow with pawa.
PSA 89:25 I go make am rule many kingdoms and en pawa go strong well-well.
PSA 89:26 Den e go koll mi kon sey, ‘Yu bi my Papa, my God and di Rock wey dey save mi.’
PSA 89:27 I go make am my first-born and bikos I choose am as king, na-im pipol go praiz pass for di whole world.
PSA 89:28 I go love and dey kind to am forever and my kovenant with am, nor go ever end.
PSA 89:29 I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.
PSA 89:30 But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand and disobey my laws;
PSA 89:31 if dem nor gri follow my ways or do wetin I tok,
PSA 89:32 I go ponish dem with rod kon flog dem with kane, bikos of dia sturbones and sins.
PSA 89:33 But I nor go stop to love am or forget di promise wey I make with am.
PSA 89:34 No! I nor go break my promise; I nor go take back one singol word wey I tok.
PSA 89:35 Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:
PSA 89:36 en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun.
PSA 89:37 E go dey forever like di moon and di sky go bi witness to show how I really dey faithful!”
PSA 89:38 But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren. Yu dey vex with di king wey Yu anoint.
PSA 89:39 Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust.
PSA 89:40 Yu don break di wall wey dey guide am kon distroy evritin wey dey protet am.
PSA 89:41 Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye.
PSA 89:42 Yu don give en enemies pawa kon make dem dey happy.
PSA 89:43 Yu make sure sey en swod nor mean anytin and Yu nor gri help am for war again.
PSA 89:44 Yu don end en glory kon trowey and skata en throne.
PSA 89:45 Yu don make am old before en time kon disgrace am for publik.
PSA 89:46 So, my God, na how long dis tins go happen? Yu go hide yor face forever, abi Yu go just dey vex like dat?
PSA 89:47 Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!
PSA 89:48 Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa.
PSA 89:49 So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David?
PSA 89:50 Make Yu konsida how dem dey disgrace yor savant and how I go must bear all di curse wey pipol dey curse mi.
PSA 89:51 Yor enemies dey laf and fool mi. Anywhere wey di king wey Yu anoint go, na so-so laf dem dey laf am.
PSA 89:52 But with all dis tins wey dey happen, na God wi go praiz forever and ever! Amen and Amen!
PSA 90:1 Moses Prayer My Oga God, from generashon to generashon na Yu dey protet us!
PSA 90:2 Yu bi God wey nor dey die! Even before Yu kreate di mountins and di whole world, Yu don dey.
PSA 90:3 Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey, “Make una go back to where I for kreate una!”
PSA 90:4 To Yu, one tazon years bi like one day or like some hours for nite.
PSA 90:5 Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish. Dem bi like grass wey grow for morning.
PSA 90:6 For morning, dem dey grow and shine, but for evening, dem go dry kon die.
PSA 90:7 Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.
PSA 90:8 Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.
PSA 90:9 Yes! As wi dey alive, wi dey si as Yu dey vex and awa years dey kwik-kwik end.
PSA 90:10 Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.
PSA 90:11 So na who go fit know as Yu dey vex rish? Yor vexnashon strong well-well and e dey make us fear Yu.
PSA 90:12 So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.
PSA 90:13 My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!
PSA 90:14 Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail, so dat till wi die, wi go always dey sing with joy.
PSA 90:15 Make Yu replace awa former sofa with happiness and awa bad years with good tins!
PSA 90:16 Make Yu let wi yor savants si yor works again kon allow awa shidren si yor glory.
PSA 90:17 Make di Oga awa God show us en favor, den evritin wey wi dey do, go prosper. Yes! Make Yu allow evritin wey wi dey do, prosper!
PSA 91:1 Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow.
PSA 91:2 So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.”
PSA 91:3 Bikos E go save yu from evry trap kon protet yu from doz diziz wey dey kill pesin.
PSA 91:4 E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.
PSA 91:5 So, make una nor fear di wahala for nite or di arrow wey dey fly for day time.
PSA 91:6 Make una nor fear diziz wey dey kom for darkness or trobol wey dey kom for aftanoon.
PSA 91:7 Aldo one tazon pipol go fall for una side and ten tazon dey die around una, but di enemies and dia evil nor go fit tosh una.
PSA 91:8 Una go si am with una own eyes! Yes, una go si as God dey ponish wiked pipol.
PSA 91:9 If una make God di place where una dey hide put; if una make di Most High God where una dey stay,
PSA 91:10 no evil go fit tosh una and no wahala or diziz go kom near where una dey.
PSA 91:11 Bikos E go kommand en angels make dem protet una for evritin wey una dey do.
PSA 91:12 Dem go use dia hand karry una up, so dat una nor go even kick or fall on-top stone.
PSA 91:13 Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg!
PSA 91:14 God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name.
PSA 91:15 Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.
PSA 91:16 I go bless dem with long life and give dem my salvashon.”
PSA 92:1 Sabat Day Song E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.
PSA 92:2 For morning, e dey good to tok about yor love wey nor dey fail and for evening, wi go sing of yor faithfulnes,
PSA 92:3 with harp wey get ten rope and jita.
PSA 92:4 My God, Yu dey make mi happy bikos of evritin wey Yu do and I go sing praiz Yu, bikos Yu dey good to mi.
PSA 92:5 Wi dey si di great work wey Yu do! Di tins wey Yu dey tink, deep well-well.
PSA 92:6 Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey:
PSA 92:7 “Wiked pipol dey grow like grass and doz wey dey do evil dey prosper, but God go distroy dem forever.”
PSA 92:8 But Yu, my Oga God, dem go praiz Yu forever.
PSA 92:9 Yor enemies go die trowey and all di pipol wey dey do evil, go skata.
PSA 92:10 But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi.
PSA 92:11 My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol.
PSA 92:12 But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree and dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon.
PSA 92:13 Bikos God don plant dem for en house, dem go grow well.
PSA 92:14 Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well.
PSA 92:15 Dem go sey, “God dey judge well! Na-im bi awa Rock and E nor dey do bad tin!”
PSA 93:1 God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
PSA 93:2 My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever.
PSA 93:3 My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
PSA 93:4 Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed. God get pawa pass all dis tins!
PSA 93:5 My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.
PSA 94:1 My Oga wey dey fight for pipol. Di God wey dey take revensh, make Yu show us yor glory!
PSA 94:2 Raiz-up make Yu judge di pipol for di world kon give proud pipol wetin dem deserve.
PSA 94:3 My God, na wen Yu won take judge wiked pipol? Na how long wiked pipol go dey celebrate?
PSA 94:4 How long dem go dey tok anyhow? Na how long dis wiked pipol go dey make mout?
PSA 94:5 Oga God, dem dey kill yor pipol and wound doz wey Yu koll yor own.
PSA 94:6 Dem dey kill wimen wey dia husband don die, strenjas and shidren wey nor get papa and mama again.
PSA 94:7 Dem sey, “God nor dey si us! Israel God nor even kare about wetin dey happen.”
PSA 94:8 But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?
PSA 94:9 Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
PSA 94:10 If E fit ponish wiked nashons, una tink sey E nor go ponish una? E know evritin, so make una nor tink sey E nor know wetin una dey do.
PSA 94:11 God know wetin pipol dey tink; E know sey wetin human being dey tink, dey yuzles!
PSA 94:12 So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.
PSA 94:13 Yu dey free dem from trobol and dem go dig pit wey go katch dia enemies.
PSA 94:14 God nor go rijet en pipol; E nor go leave di pipol wey E love well-well.
PSA 94:15 God good judgement go kom again and doz wey get betta and klean heart, go dey save.
PSA 94:16 Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?
PSA 94:17 If to sey God nor kom help mi, I for don die and pipol for don forget mi.
PSA 94:18 But I shaut kon kry sey, “I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail, kom support mi.
PSA 94:19 Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort, give mi new hope and make mi trust Yu.
PSA 94:20 Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!
PSA 94:21 Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.
PSA 94:22 But na God bi di place where I hide put; na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
PSA 94:23 So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.
PSA 95:1 Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.
PSA 95:2 As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.
PSA 95:3 Di Oga na great God! Na great King wey pass evry oda god.
PSA 95:4 Under di eart dey en hand and na-im get di mountins too.
PSA 95:5 Na-im get di sea, bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too.
PSA 95:6 Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,
PSA 95:7 bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.
PSA 95:8 God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.
PSA 95:9 Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do, dem still test and try my patient.
PSA 95:10 So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’
PSA 95:11 So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”
PSA 96:1 Make una sing new song for God! Make di whole world sing to am!
PSA 96:2 Make una sing and praiz God name. Evriday, make una tok about di good news sey, “E dey save en pipol.”
PSA 96:3 Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons. Make una tell evribody about di good-good tins wey E do.
PSA 96:4 God dey great! Make all praiz bi en own! E big pass all di oda gods.
PSA 96:5 Oda nashons god, na just juju dem bi, but na awa God make di heavens!
PSA 96:6 Honor and majesty dey round am; strent and beauti dey en temple.
PSA 96:7 Make all di nashons for di world know God well; make dem know sey God strong well-well and E get glory.
PSA 96:8 Make una give God di glory wey bi en own! Make una bring una ofrin as una dey enter en temple.
PSA 96:9 Make una woship God with all en glory and wonders. Make all di eart shake fall for en front.
PSA 96:10 Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!” Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am. God go judge evribody akordin to wetin dem do.
PSA 96:11 Make di heavens and di eart dey happy! Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!
PSA 96:12 Make di field and di plants, shaut for joy! Make di trees for forest dey make sound with praiz
PSA 96:13 before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart. E go judge di world well-well and E go judge evribody akordin to wetin dem do.
PSA 97:1 God na king! Make di eart happy! Make river and sea happy too.
PSA 97:2 Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
PSA 97:3 Fire dey round God for front and E burn all en enemies for evry side.
PSA 97:4 En tonda lite dey shine round di eart, so wen di eart si am, e kon dey shake.
PSA 97:5 Di mountins dey melt like butter wen dem si God wey get di whole eart.
PSA 97:6 Di heavens dey tok about en raitiousness; evribody dey si en glory.
PSA 97:7 But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
PSA 97:8 Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy, bikos of how God dey judge pipol!
PSA 97:9 Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.
PSA 97:10 Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.
PSA 97:11 Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.
PSA 97:12 So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!
PSA 98:1 Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand.
PSA 98:2 God show en pawa to diliver and en goodness to evribody!
PSA 98:3 E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory.
PSA 98:4 So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
PSA 98:5 Make dem sing dia praiz give God with harp, sweet-sweet songs,
PSA 98:6 trumpets and di sound from ram horn. Make una sing with praiz, before di King wey bi awa God.
PSA 98:7 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too.
PSA 98:8 Make di rivers klap dia hand as dem dey praiz God. Make di hills sing dia song for joy
PSA 98:9 before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness.
PSA 99:1 Na God bi king! Make di nashons shake with fear! E sidan for en throne where di angels wey get feadas dey and make di eart shake.
PSA 99:2 God dey great for Zion and naim bi Oga ova all di nashons.
PSA 99:3 So, make wi praiz God great and wonderful name, bikos E dey holy!
PSA 99:4 Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.
PSA 99:5 So make una praiz di Oga awa God! Make una bow woship am, bikos E dey holy!
PSA 99:6 Moses and Aaron dey among en priests; Samuel na one among di pipol wey pray to am. Dem pray to God and E ansa dem.
PSA 99:7 E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.
PSA 99:8 My Oga God! Yu really ansa dem. Even doh Yu bi God wey dey ponish pipol for di bad tins wey dem do, dem still si sey Yu bi God wey dey forgive.
PSA 99:9 So make wi praiz di Oga awa God! Make wi woship am for en holy hill, bikos di Oga awa God, dey holy!
PSA 100:1 Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God!
PSA 100:2 Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am.
PSA 100:3 Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.
PSA 100:4 So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.
PSA 100:5 Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.
PSA 101:1 David Song My God, I go sing about yor love and how Yu dey judge! I go praiz Yu with difren song.
PSA 101:2 Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.
PSA 101:3 I nor go even tink to do bad tin and I nor go join pipol do bad tins.
PSA 101:4 I nor go follow bad pesin make friend; I nor go tink of evil at-all.
PSA 101:5 I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.
PSA 101:6 I go favor di good pipol wey dey di land and dem go kom stay with mi. Na only doz wey nobody dey tok bad about, go serve mi.
PSA 101:7 I nor go allow pipol wey dey deceive odas, serve for my house and doz wey dey lie, nor go stay for my present.
PSA 101:8 Evriday, I go distroy wiked pipol for di land and doz wey dey do evil, I go drive dem komot from God town.
PSA 102:1 My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!
PSA 102:2 Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.
PSA 102:3 Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.
PSA 102:4 My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.
PSA 102:5 Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.
PSA 102:6 I bi like owl for desert; like small owl for inside-inside wildaness.
PSA 102:7 I nor fit sleep, I bi like bird wey only en dey on-top roof.
PSA 102:8 My enemies dey wahala mi evriday. Dem dey laf and curse mi.
PSA 102:9 Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,
PSA 102:10 bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.
PSA 102:11 My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.
PSA 102:12 But Yu, my Oga God go sidan for yor throne forever and evry generashon go know how Yu dey great.
PSA 102:13 Yu go raiz-up kon sorry for Jerusalem, bikos dis na di time wen Yu go favor am. Yes! Dis na di rite time to help am.
PSA 102:14 Bikos yor pipol love all di stones wey dey di town wall and di dust wey dey di street.
PSA 102:15 Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,
PSA 102:16 bikos E go ribuild Jerusalem kon appear inside en glory.
PSA 102:17 Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.
PSA 102:18 So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.
PSA 102:19 Make una tell dem sey God dey look down from en temple for heaven. E dey look di eart from heaven
PSA 102:20 to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.
PSA 102:21 So, make evribody for Zion celebrate God greatness and make dem praiz am for Jerusalem
PSA 102:22 wen ever dem and di difren kingdoms gada to woship God.
PSA 102:23 E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.
PSA 102:24 I sey, “My Oga God, make Yu nor let mi die naw wen I still dey yong, bikos Yu dey from one generashon go rish anoda.
PSA 102:25 Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.
PSA 102:26 Even wen dem skata, Yu go dey forever. Dem go tear like garment and Yu go remove and distroy dem like one old klot.
PSA 102:27 But Yu go always bi who Yu bi; Yu go dey forever.
PSA 102:28 Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”
PSA 103:1 David song My soul, make Yu praiz God! Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name!
PSA 103:2 My soul, make Yu praiz God! Make Yu nor forget all di good tins wey E don do!
PSA 103:3 Na-im dey forgive pipol dia sins and dey heal difren-difren diziz.
PSA 103:4 E save awa life from di pit kon crown us with mesi and en love wey nor dey fail.
PSA 103:5 E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own.
PSA 103:6 God dey do wetin dey good and dey judge well for doz wey dem dey opress.
PSA 103:7 God show en good works to Moses and en faithfulnes to Israel pipol.
PSA 103:8 God dey sorry and show mesi to pipol well-well; E nor dey kwik vex and en love for us nor dey fail.
PSA 103:9 E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem.
PSA 103:10 E nor dey use as awa sin big rish, take ponish us.
PSA 103:11 As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.
PSA 103:12 Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us.
PSA 103:13 Just as papa dey love and pity for en shidren, na so too, God dey good and dey sorry for doz wey dey fear am.
PSA 103:14 Bikos E know how E take kreate us kon remember sey na dust wi bi.
PSA 103:15 Awa days for dis world bi like grass; just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine, but small time wi go die.
PSA 103:16 Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
PSA 103:17 But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;
PSA 103:18 doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!
PSA 103:19 God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin.
PSA 103:20 So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.
PSA 103:21 Yes! Make una praiz God, all di strong angels wey dey serve and do wetin E wont!
PSA 103:22 Evritin wey God kreate, make una praiz God for evriwhere for en kingdom. Make my soul praiz God!
PSA 104:1 My soul, make Yu praiz God! My Oga God, si as Yu dey great! Yor glory dey shine well-well kon kover evriwhere.
PSA 104:2 Yor dress dey shine like lite and Yu stresh di sky like curtain for heaven;
PSA 104:3 Yu build yor palis kon put am on-top di kloud where rain from dey kom. Yu turn di kloud to yor shariot kon dey ride am on-top di wind.
PSA 104:4 Breeze na yor messenja and fire na yor savant.
PSA 104:5 Yu build di world on-top strong foundashon, so dat nobody go fit remove am.
PSA 104:6 Yu kover di eart with wota and di wota kover di mountins.
PSA 104:7 Wen Yu kommand, wota dey vanish and wen Yu shaut, e dey bi like tonda and di wota dey kwik-kwik rush komot.
PSA 104:8 Mountins dey raiz-up and valley dey sink go di place wey Yu choose for dem.
PSA 104:9 Na Yu set where di sea go flow rish, so dat dem nor go ever kover di eart again.
PSA 104:10 Yu turn springs to rivers and dem even dey flow between mountins.
PSA 104:11 Dem dey provide wota for all di animals wey dey di field; even wiked donkey sef dey si wota drink.
PSA 104:12 Birds dey build house near di rivers and dey sing from tree for bush.
PSA 104:13 From God house for heaven, E dey send rain kom wota di mountins, so dat di seed for di eart go grow.
PSA 104:14 Yu dey make grass grow for animals to chop kon provide plant for human being to use. Yu allow us produce food from di eart;
PSA 104:15 wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.
PSA 104:16 God send rain give en tree make dem for dey grow well; di cedars for Lebanon wey E plant.
PSA 104:17 Di birds dey make dia house for der and di stork bird dey stay for di trees wey always dey green.
PSA 104:18 Wiked goat dey stay di high mountin; animals for rock dey-dey save inside dia whole.
PSA 104:19 God make di moon to mark di mont and di sun dey shine just as God program am.
PSA 104:20 God dey bring darkness and nite kom and na dat time, wiked animals for di forest, dey waka.
PSA 104:21 Even lions dey kry bikos of honga and dem dey ask God for dia food,
PSA 104:22 but wen sun don dey kom out, dem go-go back to dia house go sleep.
PSA 104:23 Den men go-go do dia work and dem go work till evening.
PSA 104:24 So my God, make Yu si all di difren tins wey Yu don do! Na sense Yu take make all of dem. Na wetin Yu kreate full di whole eart.
PSA 104:25 Di sea dey der, both wide and small ones wey get difren tins wey Yu kreate and both small and big fish, dey inside.
PSA 104:26 Di ship dey travel on-top sea and Yu still make whale dey swim and play for der too.
PSA 104:27 All wetin Yu kreate dey wait for Yu to give dem food wey dem go always dey chop.
PSA 104:28 Yu give dem food and dem kollect am; Yu open yor hand to feed dem and dem chop beleful.
PSA 104:29 Wen Yu nor ansa dem, dem go dey fear. Wen Yu remove life from dem, dem go die kon turn to san.
PSA 104:30 Na yor breath wey dey give life, Yu take kreate dem kon make dem plenty for dis eart.
PSA 104:31 God glory go always dey forever! Make God always dey happy for di living tins wey E kreate!
PSA 104:32 E look di eart and di eart shake; E tosh di mountin and dem start to bring smoke.
PSA 104:33 So I go sing to God as long as I dey; I go sing praiz to my God as long as I dey breath!
PSA 104:34 Make wetin I dey tink, make belle sweet am and I go rijoice bikos of my God.
PSA 104:35 So, make sinnas vanish komot from di eart and make wiked pipol disappear! Make my soul praiz God! Make wi praiz awa Oga God.
PSA 105:1 Make wi tank Oga God! Make wi koll en name kon tell di whole world about di tins wey E don do.
PSA 105:2 Make wi sing to am. Yes! Make wi sing to am. Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
PSA 105:3 Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.
PSA 105:4 Make wi look for God and en pawa wey E dey give! Make wi always dey look for am!
PSA 105:5 Make wi remember all di wonderful tins wey E do; en mirakles and laws wey E give
PSA 105:6 us wey bi en savants, Abraham shidren and wi wey bi Jakob wey E choose, shidren-shidren.
PSA 105:7 Na-im bi di Oga awa God. Pipol dey si di way E dey judge for di whole land.
PSA 105:8 E always dey keep en kovenant; di promise wey E make give 1,000 generashon.
PSA 105:9 Dis na di kovenant wey E make with Abraham and E swear about am give Isaak.
PSA 105:10 E give di promise to Jakob, just as E kommand and for Israel pipol, na kovenant wey nor dey end, bikos E sey:
PSA 105:11 “I go give una Kanaan land and e go bi una special propaty.”
PSA 105:12 E tok dis tin wen dem neva plenty and dat time, dem just bi strenjas for Kanaan land.
PSA 105:13 Dem waka from kountry to kountry, from one kingdom to anoda.
PSA 105:14 Yet, E nor let anybody opress dem. E warn kings bikos of dem sey:
PSA 105:15 “Make una nor tosh dis pipol wey I choose and make una nor plan to do bad tins against my profets.”
PSA 105:16 E kause honga for Kanaan land wen E nor make di groun bear betta food for dem.
PSA 105:17 Den E send Josef go Egypt for en pipol front wen en brodas sell am as slave.
PSA 105:18 Di shain for Josef leg kon dey pain am and dem put iron for en neck.
PSA 105:19 Until di time rish for Josef to do wetin e dream and tok about, God still dey test en karata.
PSA 105:20 Den Fero send for am kon free am. Na di rulers for di nashon open di prison door
PSA 105:21 and Fero make Josef oga for evritin wey dey en house; so Josef kon bi oga for evritin wey di king get.
PSA 105:22 E fit send doz wey dey serve di king as e wont kon tish doz wey dey advise di king.
PSA 105:23 Den Israel kon go Egypt and Jakob stay as strenja for Ham land.
PSA 105:24 So God kon make Israel pipol plenty and dem kon too many for dia enemies to handle.
PSA 105:25 Den God turn Egypt pipol against Israel pipol and dem kon plan against God pipol.
PSA 105:26 But God send en savant Moses with Aaron wey E choose, go free en pipol.
PSA 105:27 Dem do wonderful tins for Egypt pipol front and for Ham land.
PSA 105:28 God kover Egypt with darkness, bikos dem nor gri allow en pipol go.
PSA 105:29 E turn dia wota to blood kon poizin all dia fish.
PSA 105:30 Den frog kon full di town and dem even enter di king bedroom.
PSA 105:31 Wen God tok, fly kon enter Egypt and worm kon full evriwhere.
PSA 105:32 God allow strong block fall for Egypt instead of ordinary rain and tonda dey make nois for di whole land.
PSA 105:33 E distroy dia grape vine and fig tree kon skata all dia trees.
PSA 105:34 God tok and many-many lokust kon kom; small-small lokust wey dem nor fit kount.
PSA 105:35 Dem chop evry green leaf for di land kon kill all di plants for Egypt.
PSA 105:36 Den God kill both di pipol and dia animals first-born for Egypt and na dem bi di pride and joy of dia family.
PSA 105:37 God take en pipol komot from Egypt with many silva and gold and e nor get any tribe for Israel wey faint for road.
PSA 105:38 Egypt pipol happy wen Israel pipol dey komot from dia land, bikos dem dey fear Israel pipol well-well.
PSA 105:39 God kover Israel pipol with kloud kon give dem big fire as lite for nite.
PSA 105:40 Dem ask for meat and God give dem kwail bird; E give dem manna wey bi bread from heaven, so dat dem go chop beleful.
PSA 105:41 E divide di rock and wota kom out kon form river for di dry land,
PSA 105:42 bikos E remember en promise wey E make with en savant, Abraham.
PSA 105:43 So E take en pipol komot Egypt with joy; di pipol wey E choose with happiness.
PSA 105:44 Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol and dem plok fruit wey odas plant.
PSA 105:45 All dis tins happen make dem for dey follow God laws kon obey en kommand. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
PSA 106:1 Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good! E love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 106:2 Who fit kount all di wonderful mirakles wey God don do? Who go fit praiz am rish?
PSA 106:3 Joy dey for pipol wey dey do well and always dey do wetin dey rite.
PSA 106:4 My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol, make Yu remember mi; make Yu kom near and save mi.
PSA 106:5 Make I share for di joy wey Yu dey give to di pipol wey Yu choose. Make I happy, bikos yor pipol dey happy; make I praiz Yu with doz wey bi yor own.
PSA 106:6 Wi don sin like awa grand-grand papa. Wi don do plenty bad tins! Wi don do wiked tins well-well!
PSA 106:7 Awa grand-grand papa dem nor tank Yu for all wetin Yu do for dem for Egypt. Dem kwik forget all di good-good tins wey God do for dem. True-true, dem go against God kommand, afta dem cross di Red Sea.
PSA 106:8 But God still save dem, just to defend di honor for en name and to show en mighty pawa.
PSA 106:9 E kommand di Red Sea make e dry kon take Israel pipol cross am like sey na desert
PSA 106:10 and E save dem from dia enemies kon diliver dem from pipol wey won kill dem.
PSA 106:11 Den, di river kover and kill dia enemies and no one among di enemies, survive.
PSA 106:12 So en pipol kon bilive en promise and dem kon dey sing and praiz am.
PSA 106:13 But si as dem kwik forget wetin God do! Dem nor gri listin to en advise!
PSA 106:14 For di desert, dem bigin put eye for bad-bad tins kon dey test God patient for dat dry and empty land.
PSA 106:15 So God give dem wetin dem ask for, but E send diziz and wahala follow di tins.
PSA 106:16 Di pipol for di kamp kon dey jealous Moses and Aaron wey bi God priests.
PSA 106:17 Bikos of dis, di eart open kon swallow Datan, Abiram and all doz wey dey support dem.
PSA 106:18 Fire fall on-top all doz wey dey follow dem and all of dem kon die.
PSA 106:19 Den di pipol make one juju with gold for Mount Sinai kon dey bow for am.
PSA 106:20 Dem shange dia God wey get glory bikos of one juju wey dem make.
PSA 106:21 Dem forget God, dia Savior wey do many great tins for Egypt
PSA 106:22 and plenty wonderful tins for Ham and for di Red Sea.
PSA 106:23 So God kon sey E go distroy dem. But Moses, wey E choose kon stand between God and di pipol. E beg make God nor vex distroy dem.
PSA 106:24 So some pipol nor enter di promise land, bikos dem nor bilive God promise wey sey, E go kare for dem.
PSA 106:25 Instead, dem dey komplain for dia kamp and nor gri obey God.
PSA 106:26 So, God swear sey E go kill dem for di wildaness
PSA 106:27 kon skata dia shidren-shidren among di nashons and for far-far place.
PSA 106:28 Den awa grand-grand papa join bigin woship Baal for Peor, dem even chop sakrifice wey dem offa give dead body!
PSA 106:29 Dem make God vex with all dis tins, so wahala and diziz kon attack dem.
PSA 106:30 But Finehas get strong mind kon stand for di pipol and di wahala and diziz kon stop.
PSA 106:31 And from dat time, dem kon si am as raitious man.
PSA 106:32 For Meribah, di pipol make God vex kon put Moses for trobol,
PSA 106:33 bikos dem make Moses vex and e kon dey tok like fool.
PSA 106:34 Israel pipol nor gri distroy all dia enemies wey dey di land, even doh God sey make dem distroy dem.
PSA 106:35 Instead, dem bigin make friends with pipol wey nor know God kon dey follow dia wiked ways,
PSA 106:36 den dem bigin woship dia juju and na dis make all of dem fall
PSA 106:37 and dem even sakrifice dia sons and dotas give di demons.
PSA 106:38 Dem kill innocent pipol kon sakrifice dia sons and dotas give Kanaan juju, so di land kon full with innocent pipol blood.
PSA 106:39 Dem dirty diasef with di wiked tins wey dem don do and di way wey dem love juju kon make God dey vex
PSA 106:40 and na dis make God leave en pipol wey bi en special propaty.
PSA 106:41 E give dem to dia enemies and na pipol wey hate dem kon dey rule dem.
PSA 106:42 Dia enemies opress dem kon make Israel pipol dey do wetin dem tok.
PSA 106:43 Even doh God save dem many-many times, dem still choose to sin against am and dia sin kon finally distroy dem.
PSA 106:44 But God still sorry for dem wen dem dey trobol kon listin to dia kry for help.
PSA 106:45 E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.
PSA 106:46 So dia enemies wey bi dia oga, God kon make dem trit Israel pipol well.
PSA 106:47 Naw, my Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us back from evriwhere wey wi skata go, so dat wi go tank yor holy name kon happy as wi dey praiz Yu.
PSA 106:48 Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever! Make all di pipol sey, “Amen!”
PSA 107:1 Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 107:2 Make pipol wey God don save, tok about am. Make dem tell odas sey E don save dem from dia enemies.
PSA 107:3 Bikos E don gada en pipol from many land; from east and west, nort and sout,
PSA 107:4 even doz wey dey waka for di wildaness and di ones wey lost and nor get house.
PSA 107:5 Dem bin dey hongry and wota nor dey to drink and some even faint as dem dey waka,
PSA 107:6 so dem kry as dem dey trobol sey, “Awa God, make Yu kom help us!” So God save dem from dia trobol.
PSA 107:7 E take dem go where dem go for dey save; di town where dem go stay.
PSA 107:8 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.
PSA 107:9 Bikos E dey give wota to pipol wey nid am and food to doz wey dey hongry.
PSA 107:10 Some sidan for where dark pass and dem shain dem with iron,
PSA 107:11 bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok
PSA 107:12 and na dis rizin make God ponish dem, so dat dem go learn, bikos wen dem fall, nobody dey to help dem.
PSA 107:13 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
PSA 107:14 E komot dem from di darkness kon break di shains.
PSA 107:15 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem,
PSA 107:16 bikos E break di prison gate wey dem make with bronze kon kut all di bars wey dem make with iron.
PSA 107:17 Bikos some nor get sense, dem kon tok against am and dem sofa for dia sins.
PSA 107:18 Dem nor even fit chop and na die remain for dem to die.
PSA 107:19 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
PSA 107:20 E send en words kon heal dem and E take dem komot from deat hand.
PSA 107:21 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E do for dem.
PSA 107:22 Make dem tank am with sakrifice kon sing about di tins wey E do.
PSA 107:23 Some use ship for sea dey travel round di world.
PSA 107:24 Dem si all di tins wey God dey do; all di wonderful works wey E do for di deep sea.
PSA 107:25 E kommand and breeze raiz-up with all di waves for di sea.
PSA 107:26 Di waves karry di ship up-and-down for di sea and doz wey dey drive di ship fear well-well, bikos of di great wahala wey di wave dey kause.
PSA 107:27 So dem kon dey shake and stagga like pesin wey don drink and all wetin dem know, nor fit help dem.
PSA 107:28 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
PSA 107:29 God stop di wave for di sea and evriwhere kon kwayet.
PSA 107:30 Dis kon make doz wey dey drive di ship happy, den di wota karry dia ship go rish land!
PSA 107:31 So make dem praiz God, bikos of en great love and di wonderful tins wey E do for dem.
PSA 107:32 Make dem praiz am for where pipol dey and for where di leaders for di nashon gada put,
PSA 107:33 bikos E turn river to desert and spring wota to land wey dry well-well.
PSA 107:34 E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all, bikos of di wiked tins wey di pipol wey dey stay der, dey do.
PSA 107:35 But for en pipol, E turn desert to where wota full and dry land to where wota dey flow pass,
PSA 107:36 den E bring doz wey dey hongry make dem kon stay and build dia house for der.
PSA 107:37 Dem plant seeds and vine for di land kon harvest plenty fruits and food.
PSA 107:38 E bless dem, so dat dem go born kon plenty for di land and na so too E make dia animals plenty.
PSA 107:39 But as for dia enemies, dem kon dey small more-more, bikos of di pain and sofa wey dem dey face.
PSA 107:40 God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.
PSA 107:41 Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.
PSA 107:42 Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy, while wiked pipol go shut up dia mout.
PSA 107:43 So anybody wey get sense, make e learn from all dis tins and tink about how God good rish and en love wey nor dey fail.
PSA 108:1 David Song My God, I don make up my mind! I go sing and praiz Yu with all my heart!
PSA 108:2 Jita and trumpet, make una wake-up! I go wake-up for early morning kon praiz Yu with song from my mout.
PSA 108:3 My God, for evribody present, I go tank Yu. I go sing yor praiz among di nashons.
PSA 108:4 Bikos yor love wey nor dey fail, high pass di heavens. Yor faithfulnes dey rish di kloud.
PSA 108:5 My God, make all praiz bi yor own and make dem high pass di heavens. Make yor glory kover di whole eart.
PSA 108:6 Naw, make Yu save di pipol wey Yu love. Make Yu ansa and save us with yor pawa.
PSA 108:7 As God holy rish, E kon promise sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.
PSA 108:8 Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.
PSA 108:9 But Moab na my wosh-hand basin; dem bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”
PSA 108:10 So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol?
PSA 108:11 My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go fight war again?
PSA 108:12 Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help, dey yuzles
PSA 108:13 and wi know sey, with God help, wi go do mighty-mighty tins, bikos E go distroy all awa enemies.
PSA 109:1 David Song For Di Kwayamasta My God wey I dey praiz, make Yu nor rijet mi
PSA 109:2 as wiked pipol dey trobol and lie for my head.
PSA 109:3 Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
PSA 109:4 I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
PSA 109:5 Dem dey pay mi bad for good and even doh I love dem, dem hate mi.
PSA 109:6 Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am. Make una send pesin wey go tok against am for kourt.
PSA 109:7 Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
PSA 109:8 Make en years for life nor plenty and make anoda pesin take en pozishon.
PSA 109:9 Make en shidren and wife nor get papa and husband again.
PSA 109:10 Make en shidren beg waka and make dem porshu dem komot dia house.
PSA 109:11 Make pipol wey e dey owe, kollect all wetin e get and make strenjas take evritin wey e work for.
PSA 109:12 Make nobody pity for am; make nobody sorry for en shidren wey nor get papa.
PSA 109:13 Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
PSA 109:14 Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.
PSA 109:15 Yes! Make God always dey remember en sins and make nobody remember en name again.
PSA 109:16 Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.
PSA 109:17 E love to curse odas. Naw, make Yu curse am. E nor dey ever bless odas; so naw, make Yu nor bless am.
PSA 109:18 To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body or wota wey dem dey drink or betta food wey e dey chop.
PSA 109:19 Naw, make en curse go back to am kon dey with am like klot for body; make dem tie am round am like belt for en waist.”
PSA 109:20 But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.
PSA 109:21 My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
PSA 109:22 I poor well-well! I nor get anytin and na pain full my heart.
PSA 109:23 I dey fade komot dis life like shadow; I dey die komot like lokust.
PSA 109:24 Bikos I dey fast since, my legs don weak and my body don turn to ordinary skin and bone.
PSA 109:25 Pipol for evriwhere dey use mi make yeye; wen dem si mi, dem dey shake dia head dey laf.
PSA 109:26 My Oga God, make Yu help mi! Make Yu save mi, bikos of yor love wey nor dey fail.
PSA 109:27 Make dem si sey, dis na wetin Yu do kon know sey na Yu my God, do am by yorsef.
PSA 109:28 Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!
PSA 109:29 Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
PSA 109:30 But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
PSA 109:31 bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.
PSA 110:1 David Song Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”
PSA 110:2 God go make yor kingdom big and strong for Jerusalem and yu go rule ova yor enemies.
PSA 110:3 Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.
PSA 110:4 God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”
PSA 110:5 Di Oga God stand for yor rite hand to protet Yu and E go kill many kings, wons E don dey vex.
PSA 110:6 E go ponish di nashons and dead body go full dia land. Yes! E go kut pipol head full di whole world.
PSA 110:7 But di king go drink from di wota wey dey flow pass for di road kon rule forever.
PSA 111:1 Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
PSA 111:2 Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.
PSA 111:3 Evritin wey God dey do, dey show en glory and majesty; en raitiousness nor dey ever fail.
PSA 111:4 E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!
PSA 111:5 E dey give food to pipol wey dey obey am and E always dey remember en kovenant.
PSA 111:6 E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.
PSA 111:7 Evritin wey E dey do dey rite and good and pesin fit trust all en kommand,
PSA 111:8 bikos dem bi true word and dem go last forever, so wi must obey dem well and respet dem.
PSA 111:9 E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!
PSA 111:10 Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
PSA 112:1 Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
PSA 112:2 En shidren-shidren go get pawa for dis world and God go bless di pipol wey dey obey am.
PSA 112:3 Dia house get plenty good propaty with money and dia respet na forever.
PSA 112:4 Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.
PSA 112:5 Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
PSA 112:6 Evil nor go fit kill doz kind pipol. Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem.
PSA 112:7 Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem.
PSA 112:8 Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.
PSA 112:9 Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
PSA 112:10 Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.
PSA 113:1 Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am!
PSA 113:2 Make praiz bi God name naw and forever!
PSA 113:3 Pipol go praiz God name from east go rish west.
PSA 113:4 Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven.
PSA 113:5 Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?
PSA 113:6 E dey bend look di sky and di eart.
PSA 113:7 E dey take poor pipol komot from dirty kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey,
PSA 113:8 so dat E go put dem for where prince dey-dey and dem go dey with en pipol wey bi prince.
PSA 113:9 Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God!
PSA 114:1 Wen Israel pipol komot from Egypt; wen Jakob family komot from di land where dem for bi strenja,
PSA 114:2 Judah kon bi God temple and Israel kon bi en kingdom.
PSA 114:3 Di Red Sea si dem dey kom, kon run and Jordan River turn en face.
PSA 114:4 Di mountins jump like goat and di hills run like lamb.
PSA 114:5 Red sea! Na wetin make yu dey run? Jordan River na wetin make yu turn yor face?
PSA 114:6 Yu mountins, wetin make Yu jump like goat? Yu hill, why Yu run like lamb?
PSA 114:7 Yu, eart make yu shake with fear, bikos of di Oga wey bi Jakob God,
PSA 114:8 wey turn strong groun to where wota full kon bring wota kom out from strong rock.
PSA 115:1 My God! Nor bi wi get di glory! Nor bi wi, but make all glory bi yor own, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail.
PSA 115:2 Why Yu dey let di nashons sey, “Where dia God dey?”
PSA 115:3 Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.
PSA 115:4 Na silva and gold human being take make dia juju.
PSA 115:5 Di juju dem get mout, but dem nor fit tok; dem get eye, but dem nor dey si.
PSA 115:6 Dem get ear, but dem nor dey hear, dem even get nose, but dem nor fit smell anytin.
PSA 115:7 Dem get hand, but dem nor fit tosh or feel anytin. Yes! Dem still get leg, but dem nor fit waka. Dem even get trot, but dem nor fit klear am or make any sound.
PSA 115:8 Pipol wey dey make juju and all doz wey trust dem and di juju, bi like di juju wey dem make with dia own hand.
PSA 115:9 So, Israel pipol, make una trust God, bikos na-im dey help and guide una.
PSA 115:10 Una wey bi priests, Aaron shidren-shidren, make una trust God, bikos na-im dey help and protet una.
PSA 115:11 All of una wey dey obey God, make una trust am, bikos na-im dey help and guide una.
PSA 115:12 God go remember and bless us. E go bless Israel pipol and di priests wey bi Aaron shidren-shidren.
PSA 115:13 E go bless di pipol wey dey obey am; both small and big.
PSA 115:14 Make God really make una plenty; both una and una shidren.
PSA 115:15 Make God wey make heaven and eart, bless una.
PSA 115:16 Na God get di heavens, but E don give di eart to human being.
PSA 115:17 Pipol wey don die nor fit sing praiz God, bikos dem don die enter dia grave wey kwayet.
PSA 115:18 But wi go praiz God both naw and forever! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
PSA 116:1 I love God, bikos E dey hear my vois and my prayer for help.
PSA 116:2 E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi,
PSA 116:3 bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.
PSA 116:4 So I koll God name: “Oga God, abeg make Yu kom save mi!”
PSA 116:5 Naw, make una si as God kind and good rish! Dis awa God too dey pity for pesin!
PSA 116:6 God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat, E kom save mi!
PSA 116:7 So my soul go rest again, bikos God dey good to mi.
PSA 116:8 Yes! E save mi from deat kon remove tears from my eyes, so dat I nor go fall.
PSA 116:9 I dey waka for God present as I dey for dis world!
PSA 116:10 I get faith wen I sey, “My God, I bilive Yu, even doh my mind really dey trobol mi.”
PSA 116:11 As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”
PSA 116:12 So, wetin I go give God for evritin wey E don do for mi?
PSA 116:13 I go dance bikos E diliver mi kon praiz God name forever.
PSA 116:14 I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.
PSA 116:15 God dey kare for en pipol and E dey pain am well-well wen di ones wey E love, dey die.
PSA 116:16 My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.
PSA 116:17 So I go tank God with sakrifice kon pray to am.
PSA 116:18 Na for pipol present I go for do wetin I vow to God
PSA 116:19 and na for God house wey dey Jerusalem. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
PSA 117:1 Make all di nashons praiz God. Make all di pipol for di eart praiz am.
PSA 117:2 Bikos E love us with di love wey nor dey fail and God goodness dey last forever. So make una praiz God!
PSA 118:1 Make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.
PSA 118:2 Make evribody for Israel sey: “E dey good and en love dey-dey forever.”
PSA 118:3 Make Aaron shidren-shidren wey bi priests sey, “En love dey-dey forever.”
PSA 118:4 Make evribody wey dey fear God sey, “En love dey-dey forever.”
PSA 118:5 Wen I dey trobol, I pray to God and E ansa kon free mi.
PSA 118:6 God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?
PSA 118:7 Yes, God dey my side; E go help mi. I go dey happy, bikos I don win di pipol wey hate mi.
PSA 118:8 E betta to trust God, dan to trust human being.
PSA 118:9 E betta to trust God, dan to trust prince dem.
PSA 118:10 Wiked nashons gada around mi, but I distroy all of dem with God pawa.
PSA 118:11 Yes! Dem gada round kon attack mi, but I distroy all of dem with God mighty pawa.
PSA 118:12 Dem gada mi like bee, but dem die kwik like bush wey dey burn, bikos I distroy all of dem with God pawa.
PSA 118:13 My enemies try well-well to kill mi, but di Oga my God save mi.
PSA 118:14 Na God dey give mi pawa kon make mi sing new song; E don make mi win all of dem.
PSA 118:15 Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!
PSA 118:16 God don win di war with en strong rite hand. Yes! E don do many wonderful tins with en rite hand.
PSA 118:17 So I nor go die, instead I go live to tok about all di wonderful tins wey God don do.
PSA 118:18 Even doh God don ponish mi well-well, E nor let mi die.
PSA 118:19 Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.
PSA 118:20 Na dis gate dem dey pass go God present and pipol wey dey obey God, dey pass der enter.
PSA 118:21 I dey tank Yu sey Yu ansa my prayers kon make us win,
PSA 118:22 bikos di stone wey di pipol wey dey build rijet, don turn to di main stone.
PSA 118:23 Dis na God handwork and e dey wonderful for awa eye.
PSA 118:24 Dis na di day wey God make, so wi go always dey happy, bikos of am.
PSA 118:25 Oga God, wi dey beg make Yu save us! Wi dey beg make Yu make us prosper.
PSA 118:26 Make una bless di pesin wey dey kom with God name. Yes! Wi bless Yu from God house.
PSA 118:27 Di Oga na God, so make wi start di celebrashon with sakrifice, as wi dey mash round di altar with bambo leaf for awa hand.
PSA 118:28 Na Yu bi my God and I go praiz Yu! Na Yu bi my God and I go lift yor name high!
PSA 118:29 So make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.
PSA 119:1 Make una si as God dey bless pipol wey dey do wetin dey rite and obey en kommand.
PSA 119:2 Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.
PSA 119:3 Dem nor dey do bad tins and dem always dey obey God word.
PSA 119:4 God sey make wi obey and keep yor kommand well-well.
PSA 119:5 If to sey I fit live my life just as Yu tok
PSA 119:6 den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok.
PSA 119:7 As I dey learn evritin about yor raitiousness, I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am!
PSA 119:8 I go obey yor laws, so my Oga God, make Yu nor taya for mi!
PSA 119:9 Di only way yong pesin go if live betta life, na to obey God word.
PSA 119:10 I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.
PSA 119:11 I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.
PSA 119:12 My God, I go praiz Yu, so make Yu tish mi yor laws.
PSA 119:13 I dey shaut and tok about all di kommands wey Yu give us.
PSA 119:14 Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
PSA 119:15 I go learn yor kommand kon study yor laws.
PSA 119:16 I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
PSA 119:17 Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word.
PSA 119:18 Make Yu open my eyes to si di wonderful tins wey dey yor law.
PSA 119:19 Na strenja I bi for dis world, so make Yu nor hide yor kommand from mi!
PSA 119:20 I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
PSA 119:21 Yu porshu sturbon pipol; doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis, curse dey dia head.
PSA 119:22 So make Yu nor let dem laf and curse mi, bikos I dey obey yor kommand.
PSA 119:23 Even doh important pipol sidan dey plan against mi, I go still dey tink of yor kommand,
PSA 119:24 bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.
PSA 119:25 I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word.
PSA 119:26 I tell Yu about my problems and Yu ansa mi. Naw, make Yu tish mi yor laws.
PSA 119:27 Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
PSA 119:28 Make Yu enkourage mi with yor word, so dat my pains nor go kill mi.
PSA 119:29 Make Yu nor let mi dey deceive mysef; but make Yu allow mi know yor ways.
PSA 119:30 I don choose to follow Yu; I don gri to live my life as yor word tok.
PSA 119:31 I hold yor laws well, so my God, make Yu nor let shame katch mi!
PSA 119:32 I go run follow yor kommands, bikos Yu dey make mi undastand life well-well.
PSA 119:33 My God, make Yu tish mi yor laws and I go obey dem till I die.
PSA 119:34 Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.
PSA 119:35 Make Yu let mi follow yor kommand, bikos na der my happiness dey.
PSA 119:36 Instead of to dey love money, make Yu let mi dey worry to know yor laws!
PSA 119:37 Make Yu help mi take my eyes komot from tins wey nor mean anytin and give mi life thru yor word.
PSA 119:38 Make Yu tell mi again about yor promise wey Yu make to di pipol wey dey fear and obey Yu.
PSA 119:39 Di tins wey dey make mi fear, make Yu take dem komot from my life, bikos yor law dey good.
PSA 119:40 I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
PSA 119:41 My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi.
PSA 119:42 Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi, bikos I trust yor word.
PSA 119:43 Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope!
PSA 119:44 Den I go always dey obey yor laws forever and ever.
PSA 119:45 I go dey save, bikos na only yor kommand I dey follow.
PSA 119:46 I go speak to kings about yor laws and I nor go shame.
PSA 119:47 Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
PSA 119:48 I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.
PSA 119:49 Make Yu remember di promise wey Yu make give mi, bikos na-im bi my only hope.
PSA 119:50 Yor promise dey revive and help mi wen I dey for trobol.
PSA 119:51 Na so-so laf wiked pipol dey laf mi, yet, I dey still obey yor laws.
PSA 119:52 My Oga God, I dey tink about yor laws wey dey since and dem dey konfort my soul.
PSA 119:53 I dey vex for wiked pipol, bikos dem rijet wetin Yu tok.
PSA 119:54 Anywhere wey I dey, na yor law bi di song wey I dey sing.
PSA 119:55 My God, for nite, I dey remember yor name and I dey obey yor kommand.
PSA 119:56 Na to obey yor kommand bi evritin wey I dey do for dis life.
PSA 119:57 Na Oga God dey guide and save mi! So I promise to always dey obey yor word!
PSA 119:58 I wont yor blessing with all my heart, so make Yu show mi mesi, just as Yu promise.
PSA 119:59 Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.
PSA 119:60 So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.
PSA 119:61 Wiked pipol dey won drag mi enter sin, but yor word dey strong for my heart.
PSA 119:62 I dey wake-up for nite dey tank Yu, bikos of yor good laws.
PSA 119:63 Na pipol wey dey fear Yu bi my friends; doz wey dey obey yor kommand.
PSA 119:64 My God, yor love wey nor dey fail, full di world; so make Yu tish us yor laws!
PSA 119:65 My God, Yu don do many good tins for mi just as Yu promise!
PSA 119:66 I bilive yor kommand and naw, make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws!
PSA 119:67 I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways, but naw, I dey obey yor word.
PSA 119:68 Yu dey good and na only good tins Yu dey do; so make Yu tish mi yor kommand!
PSA 119:69 Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.
PSA 119:70 Dia heart dey empty and stupid, but I dey happy for yor kommand.
PSA 119:71 My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.
PSA 119:72 Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.
PSA 119:73 Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.
PSA 119:74 Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
PSA 119:75 My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.
PSA 119:76 Naw, make yor love wey nor dey fail, konfort mi, just as Yu promise mi wey bi yor savant.
PSA 119:77 Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
PSA 119:78 Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head; but I go always dey follow yor kommand.
PSA 119:79 Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu; doz wey know yor laws.
PSA 119:80 As I dey keep yor kommand, make evritin wey I dey do, good for yor eye, so dat shame nor go katch mi.
PSA 119:81 I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
PSA 119:82 My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen. So wen Yu go kom help mi?
PSA 119:83 I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full, yet I neva forget to obey yor kommandment.
PSA 119:84 So, na how long I go dey wait? Na wen Yu go ponish di pipol wey dey wahala mi?
PSA 119:85 Doz wiked pipol wey hate yor laws don dig pit to katch mi.
PSA 119:86 But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.
PSA 119:87 Even doh dem don nearly kill mi, I still dey obey yor kommands.
PSA 119:88 So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail; den I go kontinue to obey yor laws.
PSA 119:89 My God, yor word wey dey forever, stand gidigba for heaven.
PSA 119:90 Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart, e still dey kon rish naw.
PSA 119:91 Evritin dey as dem dey kon rish today, bikos evritin dey work as Yu plan am.
PSA 119:92 If to sey yor laws nor keep mi with joy, I for don die with my pains.
PSA 119:93 I nor go ever forget yor kommand, bikos na dem Yu take dey give mi life.
PSA 119:94 I bi yor own, so make Yu save mi, bikos I don work well-well to obey yor kommand.
PSA 119:95 Even doh wiked pipol dey hide for road to kill mi, I kwayet as I keep yor laws for my mind.
PSA 119:96 Naw, I don know sey evritin get where dem fit do rish and evribody get where dem know rish, but nobody fit undastand yor kommandment finish.
PSA 119:97 My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.
PSA 119:98 Yor kommandment make mi get sense pass my enemies, bikos na dem dey always guide mi.
PSA 119:99 Yes, I get betta undastandin pass my tishas, bikos I always dey tink of yor laws.
PSA 119:100 I even get sense pass my eldas, bikos I dey keep yor kommandment.
PSA 119:101 I don decide sey I nor go do any bad tin, so dat I go always dey obey yor word.
PSA 119:102 I neva sin against yor laws, bikos Yu tish mi well.
PSA 119:103 Yor word sweet well-well for my mout; dem even sweet pass honey.
PSA 119:104 Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins.
PSA 119:105 Yor word na lantan wey dey guide my leg and lite wey dey make mi si road.
PSA 119:106 I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.
PSA 119:107 My God, I don sofa well-well; so make Yu save my life just as Yu promise.
PSA 119:108 My God make Yu asept di ofrin wey my praiz bring and tish mi yor kommandment.
PSA 119:109 Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.
PSA 119:110 Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment.
PSA 119:111 Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
PSA 119:112 and I dey ready to keep wetin Yu tok till I die.
PSA 119:113 I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody, but I love yor kommandment.
PSA 119:114 Na Yu bi my proteshon and guide and na yor word dey give mi hope.
PSA 119:115 Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.
PSA 119:116 My God, make Yu give mi life as Yu promise, so dat I nor go die!
PSA 119:117 Make Yu keep mi and I go dey save; den I go always dey follow wetin Yu tok.
PSA 119:118 Yu don rijet all di pipol wey nor dey follow yor ways and naw, dem just dey fool diasef.
PSA 119:119 Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty; know wonder I dey love to obey yor laws!
PSA 119:120 I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.
PSA 119:121 I dey do wetin dey rite, so make Yu nor leave mi for doz wey dey opress mi.
PSA 119:122 Abeg, make sure sey Yu bless mi and nor let sturbon pipol opress mi!
PSA 119:123 I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi.
PSA 119:124 I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail kon tish mi yor laws.
PSA 119:125 I bi yor savant, so make Yu give mi sense, so dat I go undastand yor rules.
PSA 119:126 E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws.
PSA 119:127 True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.
PSA 119:128 All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
PSA 119:129 Yor laws dey wonderful. No wonder I dey obey dem!
PSA 119:130 Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am.
PSA 119:131 I dey hongry for yor kommandment; I dey wait for yor laws.
PSA 119:132 Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name.
PSA 119:133 Make yor words guide my step, so dat I nor go waka enter evil.
PSA 119:134 Make Yu save mi from wiked pipol wey dey opress mi; den I fit obey yor kommandment well.
PSA 119:135 Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws.
PSA 119:136 I dey kry like river wey dey flow, bikos pipol nor gri obey yor kommands.
PSA 119:137 My God, na Yu bi my raitiousness and yor laws good well-well.
PSA 119:138 Yor rules dey pafet and wi go fit trust dem.
PSA 119:139 E dey pain mi well-well wen my enemies nor gri listin to yor laws.
PSA 119:140 I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.
PSA 119:141 Even doh I nor mean anytin at-all to pipol, I nor go fit forget yor kommand.
PSA 119:142 Yor judgement na forever and yor laws dey pafet and true.
PSA 119:143 Even doh pressure and wahala dey make mi taya, yor kommand still dey make mi happy.
PSA 119:144 Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.
PSA 119:145 My God, make Yu ansa mi, bikos I dey pray with all my heart, so dat I go always dey obey yor laws.
PSA 119:146 Make Yu save mi, bikos I dey kry to Yu make I for fit obey yor kommand.
PSA 119:147 I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope.
PSA 119:148 I nor dey sleep for nite, bikos I dey tink about yor promise.
PSA 119:149 So my God, make Yu hear my kry, bikos of yor love wey nor dey fail! Make Yu save mi as Yu dey always do.
PSA 119:150 Pipol wey nor dey obey yor law dey kom attack mi; dem nor dey listin to yor kommand at-all at-all.
PSA 119:151 But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true
PSA 119:152 and I don know from small pikin sey, yor laws go dey forever and ever.
PSA 119:153 Make Yu si di sofa wey I dey sofa kom save mi, bikos I neva forget yor laws.
PSA 119:154 Make Yu kom fight and protet my life just as Yu promise.
PSA 119:155 Nobody go save wiked pipol, bikos yor laws nor koncern dem at-all.
PSA 119:156 My God, si as yor mesi great rish; so make yor laws dey give mi hope as I dey do dem.
PSA 119:157 Many pipol dey trobol and wahala mi, yet I neva run or turn from yor laws.
PSA 119:158 Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick, bikos dem nor kare about yor kommandment.
PSA 119:159 My God, make Yu si how I love yor kommands. Make Yu give mi back my life, bikos of yor love wey nor dey fail.
PSA 119:160 All yor kommand na true and all yor laws go last forever.
PSA 119:161 Pipol wey get pawa dey trobol mi wen I nor do dem anytin, but na only yor word dey make my heart shake.
PSA 119:162 Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.
PSA 119:163 Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.
PSA 119:164 I go praiz Yu seven times for one day, bikos all yor laws dey rite.
PSA 119:165 Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
PSA 119:166 My God, I dey wait since make Yu kom save mi and I dey obey yor kommand.
PSA 119:167 I dey obey yor laws, bikos I love dem well-well.
PSA 119:168 Yes, I dey obey yor kommandment and yor laws, bikos Yu know evritin wey I dey do.
PSA 119:169 My God, make Yu listin to my kry; make Yu give mi betta sense thru yor word!
PSA 119:170 Make Yu listin to my prayers kon save mi just as Yu promise.
PSA 119:171 Make praiz dey always kom out from my mout, bikos Yu don tish mi yor laws.
PSA 119:172 Make my tongue sing about yor word, bikos all yor kommandment dey rite.
PSA 119:173 Make Yu help mi, bikos I don choose to obey and follow yor kommandment.
PSA 119:174 My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
PSA 119:175 Make I dey dis life, make yor laws kon help mi, so dat I go always dey praiz Yu.
PSA 119:176 I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.
PSA 120:1 David Song Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.
PSA 120:2 My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.
PSA 120:3 Una wey sabi lie well-well, una know how God go take ponish una? Una know how una wahala go plenty rish?
PSA 120:4 Dem go shuk una with sharp arrow kon burn una with hot shako from fire.
PSA 120:5 I really sofa for Meshak town and e pain mi well-well sey I stay with Kedar pipol.
PSA 120:6 I don taya to stay among pipol wey nor like peace.
PSA 120:7 I dey look for peace; but wen ever I tok about am, na war dem dey give mi.
PSA 121:1 David Song I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?
PSA 121:2 My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart!
PSA 121:3 E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.
PSA 121:4 True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all.
PSA 121:5 Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi.
PSA 121:6 Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite.
PSA 121:7 God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.
PSA 121:8 God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.
PSA 122:1 David Song I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
PSA 122:2 And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem.
PSA 122:3 Jerusalem na strong town wey dem build well; so nor-tin go fit skata en wall.
PSA 122:4 Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
PSA 122:5 Di throne where God for dey judge kase dey for der; di throne wey bi David and en shidren-shidren own.
PSA 122:6 So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper.
PSA 122:7 My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever.
PSA 122:8 Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”
PSA 122:9 Bikos of awa Oga God house, I go pray make Jerusalem dey prosper.
PSA 123:1 David Song My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.
PSA 123:2 Just as savants dey depend on dia masta and as savant girls dey depend on dia madam, na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us.
PSA 123:3 My Oga God, make Yu sorry and pity for us, bikos wi too don get awa own share for di trobol.
PSA 123:4 Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.
PSA 124:1 David Song Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”
PSA 124:2 If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us,
PSA 124:3 dem for don swallow us alive as dem dey vex.
PSA 124:4 River for don kover us; wota for don karry us go.
PSA 124:5 Strong wave for river for don kover awa soul.
PSA 124:6 So, make wi praiz God wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit!
PSA 124:7 Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free!
PSA 124:8 God wey kreate heaven and eart, na-im diliver us from dia hand.
PSA 125:1 David Song Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
PSA 125:2 Just as mountin gada round Jerusalem, na so too God dey round en pipol, both naw and forever.
PSA 125:3 Wiked pipol nor go rule pipol wey dey fear and obey God, if not, doz wey dey obey God fit start to do bad tins too.
PSA 125:4 My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu,
PSA 125:5 but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!
PSA 126:1 David Song Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
PSA 126:2 Wi bigin laf kon dey sing for joy. So di oda nashons kon sey, “Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.”
PSA 126:3 Yes, God don do betta tin for us, so awa joy don plenty!
PSA 126:4 Oga God, just as wota dey make dry land fresh, na so too Yu go do for us wen Yu give us awa propaty back.
PSA 126:5 Pipol wey sofa plant dia seed, go harvest wetin dem plant with happiness.
PSA 126:6 Dem dey kry as dem dey go plant dia seed, but dem go dey sing with joy as dem dey kom back with wetin dem harvest.
PSA 127:1 Solomon Song Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
PSA 127:2 E dey yuzles to work hard from morning go rish nite, bikos of wetin yu go chop. Yes! God dey provide for di pipol wey E love, even wen dem dey sleep.
PSA 127:3 Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.
PSA 127:4 Pikin wey yong man born, strong like arrow for warrior hand.
PSA 127:5 Na dem bi di main rizin wey make man dey happy and shame nor go katch di man even wen e meet en enemies for di town gate.
PSA 128:1 Solomon Song Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
PSA 128:2 Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure.
PSA 128:3 Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree.
PSA 128:4 Yes! True-true, dis na God blessing for doz wey dey fear am.
PSA 128:5 Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.
PSA 128:6 Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land!
PSA 129:1 Solomon Song Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.
PSA 129:2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us.
PSA 129:3 Dem don use cutlass kut all awa back like sey na farmer klear am.
PSA 129:4 But God dey good; E don kut di rope wey wiked pipol take tie us and naw, wi don dey free.
PSA 129:5 So, make evribody wey hate Jerusalem, turn back with shame.
PSA 129:6 Make dem dey yuzles like grass wey dey on-top roof, wey go die as e dey grow
PSA 129:7 and pipol nor go plok or si am again.
PSA 129:8 Yes! Pipol wey dey waka pass nor go sey, ‘Make Oga God bless dem’ or sey, ‘Wi bless una with Oga God name.’ ”
PSA 130:1 Solomon Song My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart.
PSA 130:2 My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!
PSA 130:3 If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?
PSA 130:4 But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.
PSA 130:5 So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail.
PSA 130:6 Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.
PSA 130:7 So Israel pipol, make una put una hope for God hand, bikos God dey show en love and E always dey ready to save en pipol.
PSA 130:8 E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins.
PSA 131:1 David Song My God, my heart nor dey proud; my eyes nor dey look anyhow. I nor dey worry mysef with matter wey too heavy for mi to bear.
PSA 131:2 Instead, I dey kwayet and dey silent like pikin wey nor dey kry for breast milk again. Yes, I kwayet like pikin wey en mama karry.
PSA 131:3 So Israel pipol, make una put una hope for God hand, both naw and forever more!
PSA 132:1 David Song My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa.
PSA 132:2 E make promise give Yu and E vow give di Oga wey bi Israel God sey,
PSA 132:3 “I nor go-go my house or go sleep for my bed.
PSA 132:4 I nor go gri sleep or let sleep katch mi
PSA 132:5 until I find di place where I go build God house put; one big temple for di Oga God wey dey save Israel.”
PSA 132:6 Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town.
PSA 132:7 Make wi go God temple; make wi woship am for front of en throne.
PSA 132:8 My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey, with di Kovenant Box wey dey show yor pawa.
PSA 132:9 Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart.
PSA 132:10 Bikos I bi yor savant, make Yu nor rijet mi David, di king wey Yu choose.
PSA 132:11 God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.
PSA 132:12 Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.”
PSA 132:13 Yes! God don choose Jerusalem; E don choose di town as en own
PSA 132:14 and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am.
PSA 132:15 I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land.
PSA 132:16 I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God.
PSA 132:17 For der, I go make David pawa strong; bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever.
PSA 132:18 I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.”
PSA 133:1 David Song Make una si as e dey good and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace!
PSA 133:2 E dey bi like betta fine oil wey dem pour for pesin head, wey rush go en bear-bear. E rush go Aaron bear-bear and di holy garment wey e wear.
PSA 133:3 E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.
PSA 134:1 David Song All of una wey bi God savant and doz wey dey serve for God temple for nite, make una praiz God.
PSA 134:2 Make una raiz una hand for di temple kon praiz God!
PSA 134:3 Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion!
PSA 135:1 Make wi praiz Oga God! Make wi praiz God name! Una wey bi God savant, make una gi-am praiz.
PSA 135:2 Una wey dey serve for di kourt wey dey God temple;
PSA 135:3 make una praiz am, bikos E dey good! Make una sing praiz en name, bikos dat na wetin una suppose do!
PSA 135:4 True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.
PSA 135:5 Yes! I know sey God dey great and awa Oga God high pass oda gods.
PSA 135:6 E dey do anytin wey E like for heaven and eart, both for under di sea and ocean too.
PSA 135:7 E dey make kloud raiz kom from where di eart for end. Na en dey bring tonda kom wons rain dey fall and bring breeze kom out from where dem dey.
PSA 135:8 E kill all di first-born for Egypt, both human being and animals.
PSA 135:9 E do great tins kon judge both Egypt, Fero and all en savants just as dem deserve.
PSA 135:10 E distroy many nashons kon kill mighty kings;
PSA 135:11 Sihon wey bi Amor pipol king and King Og for Bashan and all di kingdom for Kanaan,
PSA 135:12 E give dia land to en pipol Israel, as one special propaty.
PSA 135:13 So my God, yor name go dey forever. My Oga God, dem go respet Yu forever,
PSA 135:14 bikos Yu dey save yor pipol and sorry for yor savants.
PSA 135:15 Di gods wey human being dey serve, na silva and gold dem take make dem.
PSA 135:16 Dem get mout, but dem nor fit tok; dem get eyes, but dem nor dey si;
PSA 135:17 dem get ear, but dem nor dey hear and dem nor dey breath at-all.
PSA 135:18 Pipol wey make dem, plus evribody wey trust dem, go end up like dem.
PSA 135:19 So, Israel pipol, make una praiz God! Aaron shidren-shidren, make una praiz God!
PSA 135:20 Levi family, make una praiz God! Una wey dey do evritin wey God tok, make una praiz am!
PSA 135:21 E good make evribody for Zion, praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem, make all of us, praiz am!
PSA 136:1 Make wi tank God, bikos E dey good and en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:2 Make wi tank God wey bi di oga of all gods, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:3 Make wi tank di Oga God of all ogas, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:4 Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:5 Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:6 Di Pesin wey put di eart on-top wota, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:7 Di Pesin wey make di great lite for heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever:
PSA 136:8 Di sun dey rule for day time, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
PSA 136:9 and di moon and star dey rule for nite, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:10 Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:11 Den E karry Israel pipol komot from der, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:12 E guide dem with en strong hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:13 Na-im divide di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:14 Den E take Israel pipol waka pass di river for dry land, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:15 Na-im make Fero and en sojas die inside di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:16 Na God lead en pipol pass di wildaness, bikos en love wey nor dey fail dey forever.
PSA 136:17 Di Pesin wey kill strong-strong kings for dem, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:18 E still kill great and mighty kings too, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:19 E kill King Sihon for Amor, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:20 E kill King Og for Bashan, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:21 Den E kon give dia land to en pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:22 E give di land to Israel pipol wey bi en savant, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:23 Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
PSA 136:24 den kon take us komot from awa enemies hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:25 Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
PSA 136:26 So make wi tank di Oga God wey dey heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever!
PSA 137:1 As wi sidan near Babilon River, wi kon dey kry bikos wi dey tink about Jerusalem.
PSA 137:2 Wi trowey and hang awa harps for poplar tree branches,
PSA 137:3 bikos na for der di pipol wey katch us, sey make wi sing Jerusalem song for dem; dem even dey laf us kon sey make wi dey smile as wi dey sing am.
PSA 137:4 But how wi won take sing God song for land where di pipol nor know God?
PSA 137:5 O-o my Jerusalem, if I forget yu, make my rite hand die, so dat I nor go fit play harp again.
PSA 137:6 If I nor remember Yu again or si Jerusalem as where my joy from dey kom, make my tongue gum my mout.
PSA 137:7 My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
PSA 137:8 Babilon pipol! God go soon distroy una. Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us, make happiness bi en own.
PSA 137:9 Di pesin wey go take una shidren dem take nak rock, make blessing follow am!
PSA 138:1 David Song My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
PSA 138:2 I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.
PSA 138:3 Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.
PSA 138:4 My Oga God, di king for di whole eart go tank Yu, bikos all of dem go hear yor words.
PSA 138:5 Yes! Dem go sing about God ways, bikos en glory dey great well-well.
PSA 138:6 Even doh God dey great, E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef, but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.
PSA 138:7 Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.
PSA 138:8 God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.
PSA 139:1 David Song My God, Yu shek my heart well-well and Yu know evritin about mi.
PSA 139:2 Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.
PSA 139:3 Yu dey si mi wen I dey travel and wen I dey rest for house. Yu know evritin wey I dey do.
PSA 139:4 My God, Yu know wetin I won tok even before I tok am.
PSA 139:5 Yu dey my front kon still dey follow mi for back and yor blessings dey my head.
PSA 139:6 Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!
PSA 139:7 I nor go fit hide from yor Spirit! I nor fit run komot from yor present at-all!
PSA 139:8 If I run go heaven, Yu dey der; if I die go grave, Yu dey der too.
PSA 139:9 If I sey make I fly as day dey break kon go di oda side for di sea,
PSA 139:10 yor hand go guide mi for der and yor rite hand go support mi.
PSA 139:11 Even if I sey, “darkness go kom and day go turn to nite around mi,”
PSA 139:12 e nor get how di darkness dark rish wey Yu nor go fit si mi, bikos nite brite like day for yor eye and darkness and lite na di same tin to Yu.
PSA 139:13 True-true, na Yu make my mind and my heart; na Yu arrange mi for my mama belle.
PSA 139:14 I go tank Yu, bikos di tins wey Yu dey do, dey wonderful and dey sopraiz mi. Yu know mi well-well;
PSA 139:15 my bones nor hide from Yu, even wen Yu make mi for sekret kon put mi for di eart.
PSA 139:16 Yu dey si mi wen I dey my mama belle. All di days wey I go live, dem rite am for yor book, even before dem born mi.
PSA 139:17 My God, si as e hard mi to tink about wetin Yu dey tink for mi, bikos dem plenty well-well!
PSA 139:18 If I try to kount dem, dem go many pass san-san. Even if I kount dem finish, Yu go still dey with mi.
PSA 139:19 My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish! So make wiked pipol leave mi alone o-o!
PSA 139:20 Dem nor gri do wetin Yu kommand; dem like to dey do wiked tins and awa enemies dey like to lie well-well.
PSA 139:21 So my God, si as I hate pipol wey hate and dey oppoz Yu!
PSA 139:22 True-true, I really hate dem and dem don bi my enemies naw!
PSA 139:23 Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!
PSA 139:24 Show mi anytin wey make Yu dey vex for mi. So take mi pass di road wey dey give life wey nor dey end!
PSA 140:1 David Song My God, make Yu save mi from wiked pipol! Protet mi from pipol wey like wahala;
PSA 140:2 doz wey dey plan evil for dia heart and dey kause trobol waka.
PSA 140:3 Dia tongue dey wound pipol like snake and dia lips dey bring out snake poizin.
PSA 140:4 My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand. Make Yu protet mi from doz wey like wahala, bikos dem dey plan bad against mi.
PSA 140:5 Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.
PSA 140:6 So I tell Oga sey, “Na Yu bi my God!” So my Oga God, make Yu listin wen I dey kry for help!
PSA 140:7 My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.
PSA 140:8 So make Yu nor let wiked pipol win mi, nor let dem susid with dia evil plan, if not, dem go dey proud.
PSA 140:9 Make Yu distroy my enemies with di evil and wiked tins wey dem plan for mi.
PSA 140:10 Make hot shako fall for dia head. Make Yu trow dem for fire or inside pit wey wota dey, where dem nor go fit komot or eskape.
PSA 140:11 Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.
PSA 140:12 But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol.
PSA 140:13 True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.
PSA 141:1 David Song My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom! Make Yu listin wen I kry to Yu for help!
PSA 141:2 Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.
PSA 141:3 My God, make Yu help mi kontrol my mout kon guide my lips.
PSA 141:4 Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins. Nor let mi chop sweet food wey wiked pipol kook.
PSA 141:5 Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.
PSA 141:6 Wen dem trow dia leaders down from rock, di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.
PSA 141:7 Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.
PSA 141:8 But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu. Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.
PSA 141:9 Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi; di hole wey wiked pipol dig.
PSA 141:10 Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap and free mi from dia trobol.
PSA 142:1 David Song Wen E Dey Hide I kry to God! I dey beg make E kom help mi.
PSA 142:2 I tell am all my komplain and trobols.
PSA 142:3 Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.
PSA 142:4 I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.
PSA 142:5 Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
PSA 142:6 Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.
PSA 142:7 Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”
PSA 143:1 David Song My God, make Yu hear my prayers; make Yu listin as I dey pray! Make Yu ansa mi, bikos Yu dey good and evritin wey Yu dey do, dey rite.
PSA 143:2 Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.
PSA 143:3 My enemies don porshu mi. Dem don nak mi fall kon force mi stay for darkness like pipol wey dey grave.
PSA 143:4 I nor get hope again and fear don break my body finish.
PSA 143:5 I remember before-before as I dey tink about all yor great works and doz tins wey Yu don do.
PSA 143:6 I lift my hands and pray to Yu. Just as dry land dey hongry for rain, na so too I dey hongry to si Yu.
PSA 143:7 So, my Oga God, make Yu kwik kom ansa mi, bikos my wahala dey worse evriday. Make Yu nor turn from mi, if not, I go die.
PSA 143:8 Evry morning, make I dey hear about yor love wey nor dey fail, bikos I trust Yu. Make Yu show mi where to go, bikos I don give mysef to Yu.
PSA 143:9 Oga God, make Yu save mi from my enemies; bikos I run kom meet Yu make Yu hide mi.
PSA 143:10 Make Yu tish mi to do wetin Yu wont, bikos Yu bi my God and make yor Holy Spirit guide mi as I dey waka.
PSA 143:11 My God, make Yu save mi, bikos of di glory wey dey yor name. Save mi from dis wahala, bikos of yor faithfulnes.
PSA 143:12 Use yor love wey nor dey fail, take silent all my enemies kon distroy dem, bikos I bi yor savant.
PSA 144:1 David Song I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.
PSA 144:2 E love mi and E dey protet mi. Na inside am I dey hide put and na-im bi di Pesin wey dey diliver mi. Na-im dey kover mi and di Pesin wey dey save mi. Na God dey make pipol obey mi.
PSA 144:3 My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?
PSA 144:4 Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.
PSA 144:5 Oga God, make Yu open di heavens kon kom down. Make Yu tosh di mountins, so dat smoke go kom out.
PSA 144:6 Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies! Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!
PSA 144:7 Kom down from heaven make Yu save mi; kom save mi from di deep wota and from my enemies pawa.
PSA 144:8 Na lie-lie full dia mout; dem swear sey dem go tok di trut, but na lie dem just dey lie.
PSA 144:9 My God, I go sing new song to Yu! I go use jita wey get ten rope take sing and praiz Yu.
PSA 144:10 Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.
PSA 144:11 Save and diliver mi from my enemies pawa, bikos na lie-lie full dia mout and even doh dem swear sey dem go tok trut, na lie dem still dey tok.
PSA 144:12 Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.
PSA 144:13 Make difren-difren food full awa store house. Make di animals wey dey awa land dey plenty more-more.
PSA 144:14 Make awa melu karry many propaty as dem dey kom. Make no enemy break enter awa wall kon katch us and make peace dey awa town.
PSA 144:15 Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy! True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.
PSA 145:1 David Song I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.
PSA 145:2 I go praiz Yu evriday. Yes! I go praiz Yu forever.
PSA 145:3 God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz! Nobody fit measure as E big rish.
PSA 145:4 Make evribody tell dia shidren-shidren about God mighty pawa; make dem tok about evritin wey Yu don do.
PSA 145:5 I go always dey tink of yor majesty, yor wonderful works and all yor mirakles wey yu do.
PSA 145:6 I go always dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do and I go tell evribody about di great tins wey Yu don do.
PSA 145:7 Evribody go tok di story about di wonderful tins wey Yu don do; dem go sing with joy about yor raitiousness.
PSA 145:8 God get mesi and dey sorry for pipol! E nor dey kwik vex and en love nor dey ever fail.
PSA 145:9 God dey good to evribody. E dey sorry for evritin wey E kreate.
PSA 145:10 So Oga God, all yor works go tank Yu and di pipol wey bilive Yu, go praiz Yu.
PSA 145:11 Dem go tok about di glory wey dey yor kingdom; dem go tell pipol about yor pawa.
PSA 145:12 Dem go tok about di wonderful tins wey Yu don do and about di majesty and glory wey Yu take dey rule,
PSA 145:13 bikos yor kingdom go dey forever and ever. Yu dey rule from one generashon go rish anoda.
PSA 145:14 God dey help pipol wey don fall kon support doz wey dia load too heavy to karry.
PSA 145:15 So my God, evritin dey look up to Yu and Yu dey give dem dia food wen dem wont am.
PSA 145:16 Wen Yu open yor hand, doz wey dey hongry and nid wota, Yu dey make dem beleful.
PSA 145:17 God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body.
PSA 145:18 God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.
PSA 145:19 Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.
PSA 145:20 God dey protet all di pipol wey love am, but E dey distroy wiked pipol.
PSA 145:21 So, I go praiz God and make evribody for eart bless en holy name forever and ever.
PSA 146:1 Praiz God! My soul, make yu praiz God.
PSA 146:2 I go praiz God as long as I dey alive. Even if I dey die, I go sing praiz to God.
PSA 146:3 Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.
PSA 146:4 Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
PSA 146:5 But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.
PSA 146:6 Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.
PSA 146:7 Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison.
PSA 146:8 God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am.
PSA 146:9 God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.
PSA 146:10 So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God!
PSA 147:1 Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
PSA 147:2 God dey ribuild Jerusalem and E go bring en pipol kom back to Israel from di land where dem dey.
PSA 147:3 E heal pipol wey dia heart don break kon trit dia sore.
PSA 147:4 E dey kount and koll di stars by dia names.
PSA 147:5 Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!
PSA 147:6 God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey.
PSA 147:7 So, make una sing tank God; make una use harp take sing praiz awa God.
PSA 147:8 E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart, den E make grass grow on-top mountins.
PSA 147:9 E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.
PSA 147:10 E nor kare about di pawa wey horse get or di one wey human being get.
PSA 147:11 No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.
PSA 147:12 So, Jerusalem pipol! Make una praiz God! Pipol for Zion, make una gi-am all di praiz!
PSA 147:13 Bikos E don make di iron for una gate strong kon bless all una shidren.
PSA 147:14 E send peace kom una land kon make una chop betta food.
PSA 147:15 E send en laws kom di world; so make una si as en word kwik kom meet una!
PSA 147:16 E send snow kom like as wool dey fall; E skata snow for groun like ashes.
PSA 147:17 E trow big-big stones with fire kom di eart. So, na who fit stand face God kold breeze wey fit turn pesin to ice-blok?
PSA 147:18 But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt. E send en breeze and di ice-blok kon turn wota.
PSA 147:19 E don show Jakob en word, kommands and rules for Israel pipol.
PSA 147:20 E neva do like dis for any oda nashon; no oda nashon know en rules and kommand. So make wi praiz God!
PSA 148:1 Make wi praiz God! Make wi praiz God from heaven! Make wi praiz am from di sky!
PSA 148:2 Make all en angels praiz am! Make all di sojas for heaven, praiz am!
PSA 148:3 Make di sun and di moon, praiz am! Make all di stars wey dey shine, praiz am!
PSA 148:4 Make di sky, praiz am! Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am!
PSA 148:5 Make evritin wey God kreate, praiz am, bikos E just kommand and evritin kon dey as dem dey.
PSA 148:6 E put dem for where dem dey forever and ever. Nobody fit tok against en kommand.
PSA 148:7 Make all di tins wey dey inside di sea and di ones for land, praiz God.
PSA 148:8 Make big-big stones with fire, snow and kloud, wind and weda, obey am.
PSA 148:9 Mountins and all di hills; trees and all di cedars;
PSA 148:10 wild animals and ordinary animal; animals wey dey creep for groun and birds;
PSA 148:11 kings for di eart and all di pipol; doz wey dey rule and judge di eart;
PSA 148:12 yong men and yong wimen; old men and shidren, make all of dem praiz God.
PSA 148:13 Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven!
PSA 148:14 E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!
PSA 149:1 Make wi praiz di Oga wey bi awa God kon sing new song to am. Make wi sing praiz am for where en pipol gada put.
PSA 149:2 Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.
PSA 149:3 Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
PSA 149:4 bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef, E dey make dem win.
PSA 149:5 Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem! Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
PSA 149:6 As dem hold swod wey get two mout for dia hand, make dem praiz God,
PSA 149:7 so dat dem go fit revensh dia enemies kon ponish di strenjas.
PSA 149:8 Dem tie dia enemies kings with shains and dia priests with iron
PSA 149:9 and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
PSA 150:1 Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
PSA 150:2 Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do; make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!
PSA 150:3 Make wi praiz am with trumpet sound; make wi praiz am with jita and harp!
PSA 150:4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke; make wi praiz am with jita and flute!
PSA 150:5 Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am. Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.
PSA 150:6 Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!
PRO 1:1 Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word.
PRO 1:2 E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
PRO 1:3 Dis words go tish una how to live betta life, to dey honest and to dey tok trut and korrect word.
PRO 1:4 Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense and e go tish yong men how to work and get money.
PRO 1:5 Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
PRO 1:6 so dat dem go fit undastand proverbs, parabols and wetin wise pipol dey tok.
PRO 1:7 For yu to get wisdom, yu most fear God, but na only foolish pipol dey rijet wisdom and good advise.
PRO 1:8 My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,
PRO 1:9 bikos wetin dem dey tish yu go bi like betta shain for yor neck and betta kap for yor head.
PRO 1:10 My pikin, wen sinnas tempt yu, make yu nor fall for dem.
PRO 1:11 If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem.
PRO 1:12 If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw, dem go die wen wi don deal with dem finish!
PRO 1:13 Den wi go si plenty good tins karry kom awa house.
PRO 1:14 So, kom join us make wi go divide wetin wi tif.”
PRO 1:15 My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all.
PRO 1:16 Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.
PRO 1:17 E nor dey good to set trap wen di bird wey yu won katch dey look yu.
PRO 1:18 But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem.
PRO 1:19 Dis na wetin dey happen to pipol wey play wayo take get propaty.
PRO 1:20 Wisdom dey koll pipol for street and inside market,
PRO 1:21 e dey shaut dey koll dem from di town gate and anywhere wey pipol gada put.
PRO 1:22 Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
PRO 1:23 How I wish una go gri listin, den I for give una good advise kon share my wisdom with una.
PRO 1:24 I dey koll and invite una since, but una nor gri listin or hear mi.
PRO 1:25 Una nor gri take my advise or allow mi korrect una.
PRO 1:26 So, I go laf una wen una enter trobol kon take una do yeye wen wahala start.
PRO 1:27 Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze and una pain go sirious well-well.
PRO 1:28 Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.
PRO 1:29 Una nor ever get wetin to do with wisdom and una nor gri obey God.
PRO 1:30 Una nor wont my advise or listin to mi wen I dey korrect una.
PRO 1:31 So, una go get wetin fit una and wetin una do, go make una sick.
PRO 1:32 Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem.
PRO 1:33 But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.
PRO 2:1 My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu and nor ever forget wetin I sey make yu do.
PRO 2:2 Listin to wetin dey wise and try make yu undastand am.
PRO 2:3 Yes, make yu beg for wisdom and yu go get undastandin.
PRO 2:4 Find am well-well, just as yu go take look for silva or oda good tins.
PRO 2:5 If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God and yu go susid as yu dey learn about God.
PRO 2:6 Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.
PRO 2:7 E dey help and protet raitious and honest pipol.
PRO 2:8 E dey protet pipol wey dey trit odas well kon guide doz wey dey respet am.
PRO 2:9 So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do.
PRO 2:10 Yu go dey wise and di sense wey yu get go give yu happiness.
PRO 2:11 Di sense and undastandin wey yu go get, go protet yu.
PRO 2:12 Wisdom go save yu from wiked pipol; from doz wey dey lie well-well.
PRO 2:13 From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;
PRO 2:14 and dem dey happy to do yeye and wiked tins.
PRO 2:15 E go still save yu from pipol wey dem nor fit trust;
PRO 2:16 from ashawo wimen wey get sweet mout and doz wey won sleep with yu.
PRO 2:17 Dis kind woman nor dey faithful to en husband and e don forget di holy promise wey e make.
PRO 2:18 If yu go en house, yu just won kill yorsef bi dat.
PRO 2:19 Nobody wey go visit am, dey kom back alive. True-true, e nor go ever kom back to life again.
PRO 2:20 So, make yu follow wetin good pipol dey do, so dat yu go fit live betta life.
PRO 2:21 Raitious pipol and doz wey get respet go stay for di land wey bi awa own.
PRO 2:22 But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.
PRO 3:1 My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.
PRO 3:2 Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life.
PRO 3:3 So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.
PRO 3:4 If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.
PRO 3:5 Make yu always dey trust God with all yor heart, but nor trust wetin yu tink sey yu know.
PRO 3:6 Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
PRO 3:7 Nor tink sey yu wise pass di way yu bi, but just obey God and nor do bad tins.
PRO 3:8 If yu do like dis, yor body go dey okay and yor bones go strong well-well.
PRO 3:9 Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.
PRO 3:10 If yu do so, korn go full yor store and yu go get plenty wine to keep.
PRO 3:11 My pikin, if God korrect yu, listin well and take am as warnin.
PRO 3:12 Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.
PRO 3:13 Pesin wey wise and get undastandin, na happiness go bi en own.
PRO 3:14 Undastandin get gain pass silva and e betta pass gold.
PRO 3:15 Wisdom get value pass gold and e nor get anytin wey yu fit use take kompare am.
PRO 3:16 E go give yu long life, plenty propaty and honor.
PRO 3:17 E go still make yor life sweet and yu go dey save.
PRO 3:18 Wisdom na tree wey dey give life and e dey make pipol wey kom meet am, happy.
PRO 3:19 God kreate di eart with en wisdom and na en undastandin E take make di heavens.
PRO 3:20 Na en wisdom make river dey flow and na-im dey make kloud bring rain kom di eart.
PRO 3:21 So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well and yu nor ever let dem live yu.
PRO 3:22 Dem go make yu live sweet and happy life. Dem go bi like betta shain for yor neck.
PRO 3:23 Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall.
PRO 3:24 Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break.
PRO 3:25 Yu nor nid to worry about wahala wey go just happen, just as e dey go meet wiked pipol.
PRO 3:26 God go save yu and E nor go let trap katch yu.
PRO 3:27 Anytime wey yu fit, make yu do good to pipol wey nid am.
PRO 3:28 Nor ever tell yor neighbour make e wait till tumoro, if yu know sey yu fit help am naw.
PRO 3:29 Nor ever plan bad against yor neighbour, bikos doz wey dey stay near yu, trust yu.
PRO 3:30 Nor argue with pesin just bikos yu won argue, wen yu know sey e nor do yu bad.
PRO 3:31 Nor jealous or bigin bihave like pipol wey like wahala well-well,
PRO 3:32 bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body.
PRO 3:33 God don curse wiked pipol house, while blessings full raitious pipol own.
PRO 3:34 God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol.
PRO 3:35 Pipol wey wise go get good name, but fools go only add trobol join dia disgrace.
PRO 4:1 My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
PRO 4:2 Remember evritin wey I dey tish yu, bikos dem dey good.
PRO 4:3 Wen I still bi small boy for my papa house and as my mama only pikin,
PRO 4:4 my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.
PRO 4:5 Ask for wisdom and undastandin! Nor forget or abandon wetin I tok.
PRO 4:6 If yu love wisdom, e go protet yu; if yu love am well-well, e go save yu.
PRO 4:7 Na wisdom bi di best tin to get. If yu go get any oda tin, make e bi undastandin.
PRO 4:8 Love wisdom and e go make yu great; draw am near body and e go bring respet for yu.
PRO 4:9 Wisdom go give yu grace, e go bi like fine crown for yor head.”
PRO 4:10 So my pikin! Make yu listin to mi; make yu take evritin wey I dey tell yu sirious, den yu go get long life.
PRO 4:11 I don tish yu wisdom and di korrect way to live yor life.
PRO 4:12 Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.
PRO 4:13 Make yu always remember evritin wey yu don learn, bikos na wetin yu learn go give yu good life, so make yu guide am well-well.
PRO 4:14 Nor go where wiked men gada put or follow wetin dem dey do.
PRO 4:15 Nor do or go near bad tin! Make yu rijet am kon go yor way.
PRO 4:16 Wiked pipol nor dey fit sleep until dem do bad tin. Dem nor go gri rest until dem wound pesin.
PRO 4:17 Wikedness and wahala bi like food and drink to dem.
PRO 4:18 Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.
PRO 4:19 But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.
PRO 4:20 So, my pikin, make yu hear wetin I dey tok kon listin to my words.
PRO 4:21 Nor ever let dis words leave yu, remember and protet dem with yor heart.
PRO 4:22 Bikos dem dey give life and betta body to anybody wey undastand dem.
PRO 4:23 Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.
PRO 4:24 Nor ever lie. Nor do anytin with pipol wey dey lie or tok bad words.
PRO 4:25 Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.
PRO 4:26 Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.
PRO 4:27 Make yu run from bad tins kon waka for strait road, so dat yu nor go turn go left or rite.
PRO 5:1 My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
PRO 5:2 Den yu go know how to bihave well and di way yu go dey tok, go show sey yu get wisdom.
PRO 5:3 Anoda man wife lip fit sweet like honey and en kiss dey smooth like oil,
PRO 5:4 but wen evritin don finish, yu nor go gain anytin inside escept pain and bitterness.
PRO 5:5 Di woman go take yu go where dead body dey, bikos dat road dey lead to deat.
PRO 5:6 Di woman nor dey tink about di road wey dey save; e dey waka lost but e nor know.
PRO 5:7 But my pikin, make yu listin to mi and nor forget wetin I dey tok.
PRO 5:8 Run from dat kind woman; nor even go near en door.
PRO 5:9 If yu follow am, nobody go respet yu again and strenjas go take evritin wey yu get.
PRO 5:10 Yes! Strenjas go take all yor propaty and anoda pesin go kollect evritin wey yu work for.
PRO 5:11 Den for di end, yu go kry with pains kon die go like dat.
PRO 5:12 Den yu go sey, “Why I nor follow wetin dem tish mi? Why I nor let dem korrect mi?
PRO 5:13 Why I nor obey my tishas! Why I nor do wetin dem tok?
PRO 5:14 Naw, na wons dem disgrace mi for publik.”
PRO 5:15 Just as yu go take wota from yor own well, na so too make yu dey faithful and love only yor wife.
PRO 5:16 Make yu nor just bi like river wey anybody fit drink from.
PRO 5:17 Make yu keep yorsef for yor wife alone and know bi for strenjas.
PRO 5:18 So always dey happy with yor wife and find joy for di woman wey yu marry from di biginnin,
PRO 5:19 bikos e fine and dey honbol like deer. Make en smile dey make yu happy and make en love satisfy yu.
PRO 5:20 My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman? Wetin make yu like di way anoda man wife bi?
PRO 5:21 God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.
PRO 5:22 Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
PRO 5:23 E go die bikos e nor fit kontrol ensef. Na en yeye life go send am go en grave.
PRO 6:1 My pikin, if yu gri sey yu go pay di debt wey yor friend owe
PRO 6:2 and dem kon owe yu for di promise wey yu make,
PRO 6:3 make yu follow dis my advise, so dat yu go free yorsef, bikos yu don fall enter yor neighbour hand bi dat. Just go honbol yorsef and beg yor neighbour, so dat e go free yu.
PRO 6:4 Make yu do as I tell yu before sleep go katch yu! Nor rest until yu do am.
PRO 6:5 Just try komot yorsef from di trap like bird wey komot from trap or like deer wey eskape from hunta.
PRO 6:6 Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant dey live dia life.
PRO 6:7 Dem nor get leader, govnor or who dey rule dem,
PRO 6:8 but dem dey store dia food for dry sizin, dey wait for wen rainin sizin go start.
PRO 6:9 But na how long lazy man go take dey liedan for en bed? Wen e go ever get up?
PRO 6:10 E go sey, “Make I just sleep; fold my hand and rest small.”
PRO 6:11 But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.
PRO 6:12 Wetin yuzles and wiked pipol bi like? Na lie dem just dey lie waka.
PRO 6:13 Dem go use dia eyes take make sign kon use dia legs and fingers take deceive pipol.
PRO 6:14 Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.
PRO 6:15 Bikos of dis, dem nor go know before wahala go kom meet and distroy dem finish.
PRO 6:16 E get seven tins wey God hate and E nor wont make anybody do dem and dem bi:
PRO 6:17 “Proud pipol; doz wey dey lie; doz wey dey kill innocent pipol;
PRO 6:18 pipol wey dey always tink bad tins; pipol wey dey rush to go do wiked tins;
PRO 6:19 doz wey dey lie for anoda pesin head and pipol wey dey kause trobol among dia friends.”
PRO 6:20 My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.
PRO 6:21 Always keep and lock dia words for yor heart! Tie dem round yor neck too.
PRO 6:22 Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
PRO 6:23 Wetin dem sey make yu do, bi like lite and dia korreshon go fit tish yu how to live yor life.
PRO 6:24 E go keep yu from bad wimen and from di sweet-sweet words wey oda men wife dey tok.
PRO 6:25 Nor let dia beauti tempt yu and nor let dia wayo eyes make yu fall.
PRO 6:26 Bikos to sleep with ashawo fit make man poor, but to sleep with anoda man wife go make yu luz yor life.
PRO 6:27 Yu fit put fire for yor chest make e nor burn yu?
PRO 6:28 Abi yu fit waka on-top hot shako make e nor burn yor leg?
PRO 6:29 Na so e go bi too, if yu sleep with anoda man wife and anybody wey do dat kind tin, go sofa.
PRO 6:30 Pipol fit sorry for pesin wen e tif bikos e dey hongry
PRO 6:31 but if dem katch am, e must pay back wetin e tif seven times, even if e nid to sell evritin wey e get.
PRO 6:32 But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.
PRO 6:33 Pipol go hate, beat and disgrace am and shame go follow am forever.
PRO 6:34 Bikos jealousy dey make husband vex well-well and e nor dey show mesi wen e won revensh.
PRO 6:35 E nor go gri take any money and no amount of gift go stop en vexnashon.
PRO 7:1 My pikin, make yu remember wetin I dey tok; nor forget wetin I sey make yu do.
PRO 7:2 Do wetin I tok and yu go get good life! Protet all wetin I tish yu just as yu go protet yor eye.
PRO 7:3 All wetin I tish yu, make dem always dey with yu and make yu rite dem for yor heart.
PRO 7:4 Trit wisdom like yor sista and undastandin like yor best friend.
PRO 7:5 Dem nor go make yu put eye for anoda man wife body and wimen wey get sweet mout.
PRO 7:6 One day, I dey look outside from my window
PRO 7:7 and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well.
PRO 7:8 E dey waka pass one road near di korna wey one woman dey stay. E waka near en house
PRO 7:9 for evening wen day don dark well-well.
PRO 7:10 Den di woman go meet am; e dress like ashawo and e get bad plan for mind.
PRO 7:11 Di woman dey tok anyhow and e nor dey shame, bikos e dey always waka for di street
PRO 7:12 or stand dey wait for korna and sometaims, e go dey di market side.
PRO 7:13 E trow en hand round di yong man neck, kiss am, look strait enter en eye kon sey,
PRO 7:14 “I get fresh meat for house and today, I don do wetin I promise.
PRO 7:15 Na dis make mi kom out kon look for yu and I don si yu!
PRO 7:16 I don dress my bed with fine kolour linen wey I bring from Egypt.
PRO 7:17 I don put myrrh, aloe and cinnamon perfume for di bed.
PRO 7:18 So, make yu kom! Make wi go sleep togeda till day break and wi go enjoy awasef.
PRO 7:19 Bikos my husband nor dey house; e don travel go far-far place.
PRO 7:20 E karry plenty money follow body and e nor go kom back until mont end.”
PRO 7:21 So e tempt di man with en beauti and di man fall for en sweet tok.
PRO 7:22 Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap
PRO 7:23 where arrow go for enter en heart. E bi like bird wey dey enter net and e nor know sey en life dey danger.
PRO 7:24 So naw, my pikin, make yu listin and hear wetin I dey tok.
PRO 7:25 Nor let dat kind woman win yor heart; nor run follow am at-all.
PRO 7:26 Bikos e don skata many life and distroy and kill many men.
PRO 7:27 If yu enter en house, den deat dey hongry yu, bikos na short kut to deat bi dat.
PRO 8:1 Make una hear mi! Wisdom dey koll pipol and undastandin wont make dem hear en vois.
PRO 8:2 Dem dey on-top di hill near di road! Dem stand for di oda side for di road.
PRO 8:3 Dem dey near di gate dey koll pipol wey dey enter di town sey:
PRO 8:4 “Wi dey beg and koll evribody wey dey di world.
PRO 8:5 Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.
PRO 8:6 Make una listin to mi! I get betta words to tell una and na di rite words I dey tok so.
PRO 8:7 Wetin I dey tok so, na trut; bikos I nor dey lie.
PRO 8:8 Evritin wey I tok na true; I nor dey lie or dey lead una go die.
PRO 8:9 My words dey klear and evribody wey get wisdom, go undastand dem.
PRO 8:10 Instead of silva, make una take my words; make una choose wisdom, instead of di gold wey fine pass.
PRO 8:11 Na mi bi wisdom; I betta pass gold; nor-tin una wont wey good each mi.
PRO 8:12 I bi wisdom and I get sense well-well; I still get knowledge and I dey judge well.
PRO 8:13 If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words.
PRO 8:14 Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.
PRO 8:15 I dey help kings rule well kon make rulers give korrect laws to dia pipol.
PRO 8:16 All di ruler for dis world dey rule with my help, even ofisas and prince dem too.
PRO 8:17 I love only doz wey love mi; anybody wey dey look for mi, go si mi.
PRO 8:18 I get propaty, honor, betta life and suksess to give pipol wey wont am.
PRO 8:19 Anytin wey una get from mi, betta pass di gold wey fine pass and silva wey pure well-well.
PRO 8:20 I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,
PRO 8:21 and doz wey love mi, I dey give and pak propaty full dia house.
PRO 8:22 From biginnin, na mi God first kreate, before E kreate evry oda tin.
PRO 8:23 God kreate mi before di world start. Na mi E first give life to.
PRO 8:24 Dem born mi before God make di sea or kreate wota.
PRO 8:25 Dem born mi before God make di mountins, even before E put di hills for where dem dey.
PRO 8:26 I dey before God kreate di eart, en fields or even di first san.
PRO 8:27 I dey der wen E put di sky for where e dey kon draw di boundary between eart and sea.
PRO 8:28 I still dey wen E put di kloud for sky; open di wota for di sea
PRO 8:29 kon orda sey make di wota wey dey di sea nor full pass as E kommand am. I dey der wen God lay di eart foundashon.
PRO 8:30 I dey near am like pesin wey dey design house before dem build am. Na mi dey make am happy evriday and I dey happy for en present.
PRO 8:31 I dey dance for di world wey E kreate kon dey happy with human being too.
PRO 8:32 So, make yong pipol listin to mi naw kon do wetin I tok and dem go dey happy.
PRO 8:33 Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem.
PRO 8:34 Make blessing follow di pesin wey dey listin to mi. Evriday, e dey wosh my gate and dey wait mi outside my house.
PRO 8:35 Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.
PRO 8:36 But doz wey nor find mi, dey wound demsef and anybody wey hate mi, love to die.”
PRO 9:1 Wisdom don build en house with seven pilas.
PRO 9:2 E don kill animals to take do party, mix spice for inside di wine kon put am for di tabol.
PRO 9:3 E send en savant go announce on-top di mountin for di town sey:
PRO 9:4 “Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey,
PRO 9:5 “Make una kom chop my food and drink di wine wey I mix.
PRO 9:6 Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.”
PRO 9:7 If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am.
PRO 9:8 So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.
PRO 9:9 Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
PRO 9:10 If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin.
PRO 9:11 Wisdom go add more years to yor age.
PRO 9:12 Na yu go gain if yu get wisdom, so even if yu rijet am, na yu go still sofa am.
PRO 9:13 Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow.
PRO 9:14 Di woman go sidan for front of en house or for chair for di side wey high pass for di town
PRO 9:15 kon dey koll pipol wey dey waka pass; pipol wey dey mind dia own business sey,
PRO 9:16 “Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol,
PRO 9:17 “Wota wey dem tif dey sweet well-well and bread wey dem tif chop, get betta taste.”
PRO 9:18 Doz wey fall for en trap nor know sey, anybody wey enter en house go die and doz wey don already enter don die since.
PRO 10:1 Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
PRO 10:2 Propaty wey yu use wayo take get nor go do yu any good, but trut go save yu.
PRO 10:3 God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont.
PRO 10:4 Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
PRO 10:5 Pesin wey get sense dey plok en fruit for di rite time; but na disgrace for pesin to dey sleep for harvest time.
PRO 10:6 Blessing dey follow good pipol, but wiked pipol words dey put dem for trobol.
PRO 10:7 Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever.
PRO 10:8 Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem.
PRO 10:9 Pipol wey dey tok trut dey save and sikure, but wayo pipol dey waka enter trobol.
PRO 10:10 Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace.
PRO 10:11 Good pesin word dey give long life, but wiked pesin word dey put am for trobol.
PRO 10:12 Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.
PRO 10:13 If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.
PRO 10:14 Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
PRO 10:15 Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol.
PRO 10:16 Na life bi di reward to do good, but sin dey put pesin for more trobol.
PRO 10:17 Pipol wey dey listin if dem korrect dem go get long life, but doz wey nor dey gri sey dem dey wrong, dey waka lost.
PRO 10:18 Anybody wey pritend sey e like pesin, dey lie and anybody wey dey lie waka, na fool.
PRO 10:19 Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow.
PRO 10:20 Di words wey betta pesin tok bi like pure silva, but wiked pipol words dey yuzles.
PRO 10:21 Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok, but stupid word fit kill pesin.
PRO 10:22 Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.
PRO 10:23 Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do, but pipol wey get sense, dey happy to get wisdom.
PRO 10:24 Raitious pipol dey get wetin dem wont, but wetin wiked pipol dey get, na di tin wey dem fear pass.
PRO 10:25 Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
PRO 10:26 Nor allow lazy pesin work for yu, bikos e go bi like betta wine for yor mout or like smoke wey enter yor eye.
PRO 10:27 Obey God and yu go get long life; bikos wiked pipol dey die before dia time.
PRO 10:28 Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.
PRO 10:29 God dey protet pipol wey dey tok trut, but doz wey dey do bad tins, na distroshon bi dia own.
PRO 10:30 Raitious pipol go always dey save, but wiked pipol nor go stay long for dis world.
PRO 10:31 Raitious pipol dey tok with sense, but anybody wey dey tok bad tins, go die.
PRO 10:32 If yu obey God, yu go always know di rite words to tok. But nobody go trust yu if yu always dey lie.
PRO 11:1 God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.
PRO 11:2 E good to dey honest, but na disgrace go follow proud pipol.
PRO 11:3 Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
PRO 11:4 Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu, but na to obey God bi di only tin wey go fit save yor life.
PRO 11:5 Pesin wey dey good dey always do good tins, but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu.
PRO 11:6 Raitiousness dey save doz wey dey tok trut, but doz wey dem nor fit trust, na dia own bad plans, dey kill dem.
PRO 11:7 Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.
PRO 11:8 Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol.
PRO 11:9 Doz wey nor know God, wetin dem dey tok, fit distroy pesin, but di sense wey raitious pipol take dey tok, go save life.
PRO 11:10 Just as pipol dey happy wen good pesin dey prosper, na so too dem dey happy wen wiked pesin die.
PRO 11:11 E go betta for any town wey raitious pipol bless; but wiked pipol words go distroy am.
PRO 11:12 E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout.
PRO 11:13 Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
PRO 11:14 Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall, but wen doz wey dey give yu good advise many, yu go prosper.
PRO 11:15 Trobol dey follow who promise to pay di money wey strenja owe. So, e betta if yu nor put yorsef for di matter at-all.
PRO 11:16 Dem dey respet woman wey dey respet pipol, but even with all di propaty wey wiked men get, nobody dey respet dem.
PRO 11:17 Pesin wey good dey gain favor for ensef; but wiked pipol dey bring trobol for diasef.
PRO 11:18 Wiked pipol nor get gain for anytin, but reward dey for who dey do di korrect tin.
PRO 11:19 Anybody wey ready to live rite, go get life; but pesin wey sey na bad tins e like to dey do, go die.
PRO 11:20 God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.
PRO 11:21 Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.
PRO 11:22 Fine woman wey nor get sense, bi like ring wey dem put for pig nose and mout.
PRO 11:23 Wetin good pipol wont, dey bring good result; but evribody dey vex if wiked pesin get wetin e wont.
PRO 11:24 Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.
PRO 11:25 Make yu dey give and yu go prosper; help odas and yu go get help.
PRO 11:26 Pipol go curse di pesin wey store en korn dey wait who go buy am for high prize; but dem go praiz doz wey sell am for di normal prize.
PRO 11:27 Dem go respet yu if yu get good mind; but if yu dey look for trobol waka, na trobol go follow yu.
PRO 11:28 Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.
PRO 11:29 Pesin wey bring trobol kom meet en family, nor go get anytin and foolish men go always bi savant to wise pipol.
PRO 11:30 Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.
PRO 11:31 Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.
PRO 12:1 Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
PRO 12:2 God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
PRO 12:3 Wikedness nor dey pay pesin, but nor-tin dey shake good pipol.
PRO 12:4 Good wife dey bring joy and pride to en husband; but wife wey dey bring shame for en husband bi like diziz for en bone.
PRO 12:5 Good pipol dey always tink good, but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
PRO 12:6 Wiked pipol word dey kill, but raitious pipol word dey save pipol.
PRO 12:7 Wiked pipol dey die trowey, but doz wey dey fear God, dey get long life.
PRO 12:8 Dem dey praiz pesin wey get sense, but nobody dey respet wiked pesin.
PRO 12:9 E betta make yu bi ordinary pesin wey dey work to chop, dan to dey karry body up wen yu nor even get garri to soak.
PRO 12:10 Raitious pipol dey kare for dia animals, but wiked pipol dey trit dia own anyhow.
PRO 12:11 Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
PRO 12:12 Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif, but wetin raitious pipol get, dey rish dem, bikos dem dey work for dia own food.
PRO 12:13 Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.
PRO 12:14 Wise word get gain and hard work dey bring reward.
PRO 12:15 Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.
PRO 12:16 Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
PRO 12:17 Good witness dey tok trut, but wiked pipol dey always lie.
PRO 12:18 Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
PRO 12:19 Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
PRO 12:20 Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart, but doz wey like peace, get joy for dia life.
PRO 12:21 Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God, but na trobol dey always follow wiked pipol.
PRO 12:22 God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.
PRO 12:23 Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
PRO 12:24 Na only doz wey work hard go fit lead odas, but lazy pipol go bi slave.
PRO 12:25 If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.
PRO 12:26 Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
PRO 12:27 Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch, but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
PRO 12:28 Doz wey dey follow God, go get life and dis way wey dem dey follow, nor dey kause deat.
PRO 13:1 Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
PRO 13:2 Wise word go put betta food for yor tabol, but na only wahala wiked pipol go chop.
PRO 13:3 Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins.
PRO 13:4 Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
PRO 13:5 Doz wey dey fear God nor like lie; but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause.
PRO 13:6 Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.
PRO 13:7 Poor pipol dey bihave like sey dem get money, but doz wey get money dey pritend sey dem poor.
PRO 13:8 Rish pipol fit pay anytin for dia life, but nobody dey treaten poor man.
PRO 13:9 Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body, but wiked pipol lite go soon kwensh.
PRO 13:10 To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.
PRO 13:11 Money wey pesin play wayo take get kwik-kwik, dey disappear, but di one from hard work dey last forever.
PRO 13:12 Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick, but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life.
PRO 13:13 Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.
PRO 13:14 Wise pipol word bi like wota wey dey give life and doz wey asept am, dey run from deat.
PRO 13:15 Dem dey respet pesin wey get sense, but sturbon pipol go distroy demsef.
PRO 13:16 Wise pipol dey tink before dem do anytin, but foolish pipol nor dey tink and dem dey happy sey dem foolish.
PRO 13:17 Na manaja wey nor get sense dey enter trobol, but betta manaja dey bring progress.
PRO 13:18 If yu vex sey pipol dey korrect yu, na poverty and disgrace go end yor life; but dem go honor yu, if yu asept korreshon.
PRO 13:19 If pesin get wetin e wont, e dey sweet am well-well, but na only fool nor dey gri stop di wiked tins wey e dey do.
PRO 13:20 Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
PRO 13:21 Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem, but na blessing, raitious pipol go gain.
PRO 13:22 Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren, but na doz wey dey fear God dey take evritin wey wiked pipol die leave.
PRO 13:23 Poor pesin farm fit produce many food, but wikedness dey make dem disappear.
PRO 13:24 Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
PRO 13:25 Doz wey dey fear God, go get enough food to chop, but na honga go kill wiked pipol.
PRO 14:1 Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
PRO 14:2 Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God; but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.
PRO 14:3 Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
PRO 14:4 If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.
PRO 14:5 Good witness nor dey lie, but na lie-lie, wiked pipol dey tok.
PRO 14:6 Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am, but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.
PRO 14:7 Make yu waka leave foolish pesin, if not, yu nor go undastand wen wise pesin dey tok to yu.
PRO 14:8 Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
PRO 14:9 Foolish pipol dey laf dia own foolishness, but doz wey dey fear God, dey know and ask for forgivenes.
PRO 14:10 As yu dey happy wen good tin happen to yu, na so too e go bi wen pain kom. Nobody go fit share dem with yu.
PRO 14:11 Dem go distroy wiked pipol house, but doz wey dey fear God, go prosper.
PRO 14:12 Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye, but e dey lead am to en grave.
PRO 14:13 Wen pesin dey laf, e go forget en pain, but wen di happiness don end, di pain go kom back.
PRO 14:14 Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve; na so too good pipol dey get dia reward.
PRO 14:15 Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.
PRO 14:16 Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
PRO 14:17 Pipol wey dey vex anyhow dey do foolish tins and pipol hate doz wey dey deceive odas.
PRO 14:18 Doz wey nor get sense dey wear foolishness as klot for body; but na wisdom bi wise pipol kap.
PRO 14:19 Wiked pipol go bow for good pipol; dem go bow for doz wey dey fear God.
PRO 14:20 Poor pipol neighbours hate dem, but rish pipol get many friends.
PRO 14:21 Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.
PRO 14:22 If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.
PRO 14:23 Good work dey bring gain, but yeye word dey kause poverty!
PRO 14:24 Money na crown for wise pipol head; but foolish pipol work, dey only produce bad result.
PRO 14:25 Good witness dey save pesin life, but wiked witness dey put pesin for trobol.
PRO 14:26 Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.
PRO 14:27 To fear God, na wota wey dey give pesin life and e go help yu run from deat.
PRO 14:28 Di king glory na wen en pipol dey plenty more-more; but prince wey nor get savants, nor get anytin.
PRO 14:29 Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
PRO 14:30 Wen peace dey yor heart, e go give yor body life; but jealousy bi like diziz for pesin bone.
PRO 14:31 Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.
PRO 14:32 Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
PRO 14:33 Wisdom dey follow pesin wey dey fear God; but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
PRO 14:34 Wen pipol dey fear God, dia nashon go dey great, but sin na disgrace to evribody.
PRO 14:35 Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.
PRO 15:1 Good ansa dey end vexnashon, but yeye words dey kause kworel between pipol.
PRO 15:2 Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.
PRO 15:3 God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.
PRO 15:4 Gentol word na tree wey dey give life, but lie-lie tongue dey make di spirit weak.
PRO 15:5 Na only fool nor dey listin to en mama and papa word; but anybody wey dey take korreshon, go get sense.
PRO 15:6 Pipol wey dey fear God, good tins dey always full dia house, but wetin wiked pipol get, dey bring trobol.
PRO 15:7 Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.
PRO 15:8 God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
PRO 15:9 God nor like evritin wey wiked pipol dey do, but E love doz wey dey do good.
PRO 15:10 Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well and anybody wey nor like korreshon, go die.
PRO 15:11 Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey, tok-less of human being heart!
PRO 15:12 Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon, so dem dey run from wise pipol.
PRO 15:13 Pipol dey smile wen dem dey happy, but sorrow dey make dia spirit weak.
PRO 15:14 Wise pipol dey hongry to learn, but foolish pipol dey enjoy wetin dem tink sey dem know.
PRO 15:15 Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol; but pipol wey dey happy, dey always celebrate.
PRO 15:16 E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.
PRO 15:17 E betta to chop vegitabol with pipol wey yu love, dan to chop meat with pipol wey go fit kill yu.
PRO 15:18 Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
PRO 15:19 If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.
PRO 15:20 Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa; but foolish shidren nor dey respet dia mama.
PRO 15:21 Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.
PRO 15:22 Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
PRO 15:23 Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!
PRO 15:24 Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life and nor bi di one wey go take dem go grave.
PRO 15:25 God dey skata proud pipol house, but wimen wey dia husband don die, God dey protet dia propaty.
PRO 15:26 God hate evil plans, but E like betta words.
PRO 15:27 Long-trot dey kill pesin family finish, but doz wey hate bribe, go get long life.
PRO 15:28 Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok; but na only evil words full wiked pipol mout.
PRO 15:29 God dey far from wiked pipol, but E dey hear raitious pipol prayer.
PRO 15:30 Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.
PRO 15:31 If yu listin well wen pipol dey korrect yu, yu go dey wise and get sense.
PRO 15:32 If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.
PRO 15:33 To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.
PRO 16:1 Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.
PRO 16:2 Yu fit tink sey yu dey always do di rite tin, but na God know wetin dey rite to do.
PRO 16:3 If yu tell God make E bless evritin wey yu plan to do, yu go susid.
PRO 16:4 Evritin wey God kreate get en purpose; but na wahala, wiked pipol go get.
PRO 16:5 God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.
PRO 16:6 If pesin dey honbol and faithful, God go forgi-am en sins. If yu dey fear God, yu nor go gri do bad tins.
PRO 16:7 Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.
PRO 16:8 E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
PRO 16:9 Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.
PRO 16:10 Di king dey tok with authority wey God gi-am, so make e make sure sey e dey judge well.
PRO 16:11 Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
PRO 16:12 Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.
PRO 16:13 Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
PRO 16:14 Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
PRO 16:15 Wen di king favor pesin, e dey give life; e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
PRO 16:16 E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
PRO 16:17 Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
PRO 16:18 Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.
PRO 16:19 E betta make yu dey honbol and poor, dan to join pipol wey dey karry body up kon follow dem share di propaty wey dem tif.
PRO 16:20 Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.
PRO 16:21 Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.
PRO 16:22 Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
PRO 16:23 Wise pesin dey tink well before e dey tok; so wetin e tok dey give pipol hope.
PRO 16:24 Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.
PRO 16:25 Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye, but na deat dey end am.
PRO 16:26 Pesin wey wont sometin dey work well for am, bikos e nid am.
PRO 16:27 Wiked pipol dey always look for how to wound odas; even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.
PRO 16:28 Wiked pipol dey do aproko waka; dem dey kause trobol and break friendship.
PRO 16:29 Pipol wey dey kause wahala dey deceive dia friends enter trobol.
PRO 16:30 Make yu dey kareful with doz wey dey look yu with bad eye, bikos dem don already dey tink bad tin about yu.
PRO 16:31 Na long life bi raitious pipol reward and to get white hair, na betta crown.
PRO 16:32 E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
PRO 16:33 Wi dey plan as wi wont make tins bi, but na only God dey choose wetin go happen.
PRO 17:1 E betta to chop dry bread with peace of mind, dan to get plenty food for house with kworel.
PRO 17:2 Savant wey dey bihave well go get pawa for di house pass en oga yuzles pikin and di savant go get share for di oga propaty.
PRO 17:3 Na fire dem take dey test gold and silva, but na God dey test pesin heart.
PRO 17:4 Wiked pipol dey listin to bad advise and doz wey dey lie, dey listin to lie-lie.
PRO 17:5 If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.
PRO 17:6 Papa and mama dey-dey proud of dia grand-shidren, bikos na shidren bi dia papa and mama crown.
PRO 17:7 Since betta words nor fit kom out from fool mout, how e go bi for leaders wey dey lie.
PRO 17:8 Some pipol tink sey bribe dey work like majik; dem bilive sey e fit do anytin wey dem wont.
PRO 17:9 If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad. Remember sey bad tin fit skata friendship.
PRO 17:10 Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.
PRO 17:11 Deat go kom meet wiked pipol wey dey always kause trobol.
PRO 17:12 E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.
PRO 17:13 If yu use bad take pay good, den bad tin nor go ever komot from yor house.
PRO 17:14 To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
PRO 17:15 God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent.
PRO 17:16 Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi.
PRO 17:17 Betta friend dey always show en love and yor relashon go always dey with yu wen yu dey face wahala.
PRO 17:18 Na only pesin wey nor get sense go promise to pay anoda pesin debt.
PRO 17:19 Pesin wey like to dey kworel, like trobol and If yu always dey karry body up, den yu dey kause wahala for yorsef.
PRO 17:20 Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.
PRO 17:21 Papa and mama wey dia shidren dey do like fool, na only sadnes and pain dem dey feel.
PRO 17:22 Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small.
PRO 17:23 Wiked judge dey take bribe for sekret and bikos of dat, dem nor go give korrect judgement.
PRO 17:24 Pesin wey get sense dey tink and do good tins one-by-one, but foolish pipol dey start many tins at wons.
PRO 17:25 Foolish shidren dey kause pain for dia papa and dia mama go dey regret.
PRO 17:26 E nor good make dem flog innocent pesin and e dey bad to ponish who dey do good.
PRO 17:27 Doz wey dey sure of demsef nor dey tok anyhow and kwayet pipol dey undastand tins well.
PRO 17:28 Pipol go tink sey foolish pesin get sense wen e kwayet and wen e nor tok, e go bi like pesin wey wise.
PRO 18:1 Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef; so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
PRO 18:2 Foolish pesin nor dey worry weda e undastand sometin or not; di only tin wey dey en mind, na to show how e wise rish.
PRO 18:3 Na sin and shame dey waka togeda. Wen yu luz yor honor, pipol nor go respet yu again.
PRO 18:4 Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea and fresh like river wey dey flow.
PRO 18:5 E nor good to favor who do bad, bikos good pipol nor go get korrect judgement.
PRO 18:6 Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
PRO 18:7 Foolish pesin word dey distroy am; na en own mout dey put am for trobol.
PRO 18:8 To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am, bikos e dey sweet for body.
PRO 18:9 Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.
PRO 18:10 God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
PRO 18:11 Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem like strong high wall wey dey round di town.
PRO 18:12 Respet dey kom before honor; but distroshon dey wait for proud pipol.
PRO 18:13 Make yu dey listin well before yu ansa, If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.
PRO 18:14 Di mind to live fit enkourage pesin wen e dey sick, but if e nor get strong mind, e nor get hope bi dat.
PRO 18:15 Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.
PRO 18:16 If yu won go meet important pesin, den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.
PRO 18:17 Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite, until di oda pesin ask am kweshon.
PRO 18:18 If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.
PRO 18:19 To make peace with yor broda wey yu offend, hard pass to break enter town wey dem guide well-well and kworel, dey separate friends like gate wey dem lock with key.
PRO 18:20 Wen yu tok betta words, belle go sweet yu, so make yu let good word kom out from yor mout and yu go dey happy.
PRO 18:21 Wetin yu tok fit save or distroy yor life. So yu must asept di result of wetin yu tok.
PRO 18:22 Man wey find good woman kon marry am, don si good tin and God go favor and bless am.
PRO 18:23 Poor man dey honbol ensef as e dey tok, but rish pipol dey ansa and tok anyhow.
PRO 18:24 Friendship if put yu for trobol, but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.
PRO 19:1 E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.
PRO 19:2 To wont betta life without wisdom nor good; bikos yu go enter trobol if yu nor dey patient.
PRO 19:3 Wen pesin distroy ensef with di stupid tins wey e do, e go kon blame God.
PRO 19:4 Rish pipol dey always get new friends, but poor man nor fit keep di small ones wey e get.
PRO 19:5 If yu bi lie-lie witness, dem go ponish yu and yu nor go fit eskape.
PRO 19:6 Evribody dey try make dem gain favor for rish pesin front, just as evribody dey won bi friend to doz wey fit help dem.
PRO 19:7 Man wey nor get money, nor get value for en brodas hand, even en friends dey run from am. Aldo e dey beg dem, but dem nor dey ansa am.
PRO 19:8 Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn; den remember wetin yu learn and yu go prosper.
PRO 19:9 Anybody wey tok lie for wetin e nor know, nor go fit eskape ponishment and na di lie go kill-am.
PRO 19:10 Make foolish pipol nor dey spend money anyhow and make savant nor rule leaders.
PRO 19:11 If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
PRO 19:12 Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut, but if e favor yu, e bi like rain wey dey fall.
PRO 19:13 Foolish shidren fit distroy dia papa and mama, na so too, wife wey dey komplain well-well, bi like rain wey dey drop small-small.
PRO 19:14 Pesin fit inherit en papa and mama propaty, but na only God fit gi-am wife wey get sense.
PRO 19:15 If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow, but make yu know sey honga go soon kom kill yu.
PRO 19:16 Keep God kommandment and yu go get long life; but yu go die, if yu nor follow dem.
PRO 19:17 Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.
PRO 19:18 Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn; if yu nor do like dat, yu dey help dem distroy dia life.
PRO 19:19 If pesin get hot tempa, make e ready for anytin wey go happen, bikos If yu take am komot from trobol wons, yu go still do am again.
PRO 19:20 If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
PRO 19:21 Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.
PRO 19:22 Wetin important pass na to dey loyal. E betta make yu dey poor, den to dey lie waka.
PRO 19:23 Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.
PRO 19:24 Some pipol too lazy to put food for dia own mout.
PRO 19:25 E good make dem ponish who dey karry body up, so dat pipol wey nor know anytin, go get sense. As wise pesin, yu go get more wisdom wen yu take korreshon.
PRO 19:26 Na only pesin wey nor get shame go trit en papa anyhow or nor go allow en mama kom en house.
PRO 19:27 My pikin, if yu stop to learn, yu go forget evritin wey dem tish yu.
PRO 19:28 If witness for kourt dey tok wetin e nor si, den di judge nor go fit judge well. Wiked pipol like to dey do evil tins.
PRO 19:29 Just as dem dey beat foolish pesin, na so too dem go ponish doz wey dey karry body up.
PRO 20:1 Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.
PRO 20:2 Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut; to make am vex, mean sey yu won kill yorsef.
PRO 20:3 Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.
PRO 20:4 Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest.
PRO 20:5 Betta advise for pesin heart bi like wota for inside deep well, but pesin wey get wisdom go draw am kom out.
PRO 20:6 Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful, but e go hard to find pesin wey really bi like dat.
PRO 20:7 Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren.
PRO 20:8 Wen king sidan for en throne dey judge, e dey fit know bad tin wen e si am.
PRO 20:9 E get anybody wey fit sey en mind klean well-well and e nor dey sin?
PRO 20:10 God hate pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
PRO 20:11 Even shidren dey show who dem bi with wetin dem dey do; den yu go fit know if dem good and dey honest.
PRO 20:12 Na God give us eyes to si tins and ear to hear word.
PRO 20:13 If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.
PRO 20:14 Pesin wey dey buy sometin go sey, “Dis tin too dear! E too dear!” But afta e don buy am, e go-go make mout sey “Dis tin wey I buy so, cheap well-well.”
PRO 20:15 To tok with wisdom, betta pass to get gold and silva.
PRO 20:16 Anybody wey promise sey e go pay strenja debt, make una hold en propaty until e pay am. Make una hold di propaty if e dey do am for pesin wey kom from anoda kountry.
PRO 20:17 Bread wey pesin tif dey sweet for mout, but e go bi like stone for en belle.
PRO 20:18 Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.
PRO 20:19 Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.
PRO 20:20 If yu curse yor papa and mama, yor life go end like lantan wey kwensh for darkness.
PRO 20:21 Propaty wey pesin use wayo take kwik get for life, nor dey last.
PRO 20:22 Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.
PRO 20:23 God nor like pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
PRO 20:24 Na God dey direct pesin; so how pesin won use en own mind take know as en life go bi?
PRO 20:25 E nor good make yu promise God wetin yu know sey yu nor go do.
PRO 20:26 Wise king dey skata wiked pipol like flower kon ride horse on-top dem.
PRO 20:27 God lite dey enter human being spirit kon open all di plans wey dem get.
PRO 20:28 Love wey nor dey fail and goodness dey protet di king and na dis love dey make en throne dey forever.
PRO 20:29 Yong pipol glory dey dia strent; so make una respet di white hair wey old pipol get.
PRO 20:30 Korrect ponishment dey drive evil komot from pesin mind kon make en heart klean.
PRO 21:1 Evry king heart dey God hand; just as E dey show river how e go take flow, na so too E dey kontrol kings mind.
PRO 21:2 Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.
PRO 21:3 Instead of sakrifice, make pesin do wetin good and korrect; tins wey go make belle sweet God.
PRO 21:4 Na pride dey kontrol wiked pipol and anytin wey kom out from dem, na sin e bi.
PRO 21:5 If yu plan with kare, yu go prosper; but if yu rush dey plan, na poverty go end am.
PRO 21:6 Di money wey yu use wayo take get go disappear, but dat go bi afta e don push yu put for deat hand.
PRO 21:7 Na di wahala wey wiked pipol kause dey distroy dem, bikos dem nor gri do wetin dey good.
PRO 21:8 Bad belle pipol nor gri do wetin dey rite; but innocent pipol dey do wetin dey good.
PRO 21:9 E betta make yu stay on-top house dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
PRO 21:10 Wiked pipol dey always like to do wiked tins, so dem nor dey pity for anybody.
PRO 21:11 Wen God ponish pipol wey dey karry body up, even pesin wey nor dey tink, dey learn lesin. If dem tish wise pesin, e go wise well-well.
PRO 21:12 God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.
PRO 21:13 If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
PRO 21:14 If pesin dey vex for yu; gift wey yu gi-am for sekret go kool en tempa.
PRO 21:15 Good pipol dey happy wen dem give korrect judgement, but wiked pipol hope dey die.
PRO 21:16 Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.
PRO 21:17 Pipol wey dey always spend dia money take drink and chop anyhow, nor go ever get plenty money.
PRO 21:18 Di wahala wey wiked pipol bin won kause for good pipol, na dem dey use dia own head karry am.
PRO 21:19 E betta to stay desert dan to stay house with wife wey dey komplain well-well.
PRO 21:20 Wise pesin fit get plenty money and dey enjoy ensef, but as soon as foolish pipol get dia money, dem go spend am anyhow.
PRO 21:21 Make yu dey do good and tok trut and yu go get long life; den odas go respet and trit yu well.
PRO 21:22 Wise pesin go fit take town wey strong men dey guide kon distroy di wall wey bi dia hope.
PRO 21:23 If yu nor won enter trobol, make yu tink before yu tok.
PRO 21:24 Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
PRO 21:25 Lazy pipol wey nor gri work dey kill demsef and
PRO 21:26 na wetin dem go like get, dem dey always tink about, but good pipol sabi give well-well, bikos dem nor stingy.
PRO 21:27 God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.
PRO 21:28 Pipol nor dey bilive anytin wey lie-lie pesin tok, but pesin wey dey tink before e tok, dem dey bilive en word.
PRO 21:29 Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.
PRO 21:30 Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.
PRO 21:31 Pesin fit ready en horse sey e dey go fight war, but na only God go gi-am viktory.
PRO 22:1 If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name, bikos respet betta pass silva and gold.
PRO 22:2 Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.
PRO 22:3 Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.
PRO 22:4 If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life.
PRO 22:5 Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass, but wise pipol wey sabi guide dia soul, dey-dey far from dem.
PRO 22:6 Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old, e go still dey do di same tin.
PRO 22:7 Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant.
PRO 22:8 Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
PRO 22:9 Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu.
PRO 22:10 If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again.
PRO 22:11 Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend.
PRO 22:12 God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans.
PRO 22:13 Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out.
PRO 22:14 Pesin wife wey dey sleep with oda men, dey get sweet mout and doz wey God dey vex for, dey fall enter di woman trap
PRO 22:15 Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.
PRO 22:16 If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.
PRO 22:17 Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
PRO 22:18 yu go happy, if yu remember and use dem well.
PRO 22:19 I go tell yu evritin naw, bikos I wont make yu trust God.
PRO 22:20 I don rite thirty words wey go give yu wisdom, betta advise and
PRO 22:21 tish yu wetin trut really mean. So if dem send yu go find am, yu go bring korrect ansa kom back.
PRO 22:22 Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too,
PRO 22:23 bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life.
PRO 22:24 Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa,
PRO 22:25 bikos if yu learn dia behaviour, yu nor go fit shange again.
PRO 22:26 Make yu nor promise to pay money wey anoda pesin dey owe,
PRO 22:27 bikos if yu nor fit pay, dem go kon karry yor bed go.
PRO 22:28 Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa dem take mark where dia land for end.
PRO 22:29 Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.
PRO 23:1 Wen yu sidan dey chop with important pesin, make yu dey kareful well-well.
PRO 23:2 If yu dey too chop and nor dey beleful, make yu respet yorsef.
PRO 23:3 Nor get long-trot for di fine food wey e give yu; bikos e fit use am take deceive yu.
PRO 23:4 As yu dey try to get money, make yu use yor sense, so dat life nor go taya yu,
PRO 23:5 bikos yor money fit finish wons like sey e get feada kon fly leave yu like eagle.
PRO 23:6 Make yu nor chop with stingy pesin or get long-trot for di kind food wey e kook,
PRO 23:7 bikos e go sey, “Make yu kom chop!” But e nor really tok am from en heart, bikos na as e dey tink, na so too e bi.
PRO 23:8 Yu go vomit all wetin yu don chop, den all di praiz wey yu praiz am, nor go mean anytin again.
PRO 23:9 Make yu nor try to tok sense give foolish pesin, bikos e nor go value am.
PRO 23:10 Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa dem take mark land and pikin wey nor get papa and mama, make yu nor take en land.
PRO 23:11 Na God dey defend dem and E go judge dia kase against yu.
PRO 23:12 Make yu listin to yor tishas kon learn evritin wey yu fit learn.
PRO 23:13 Make yu always ponish shidren wen dem do wrong, bikos dat ponishment nor go kill dem,
PRO 23:14 but e go save dia life.
PRO 23:15 My pikin, if yu dey wise, I go happy well-well.
PRO 23:16 I go dey proud wen I hear yu dey tok with wisdom.
PRO 23:17 Make yu nor jealous sinnas, but make to dey fear God, bi di only tin wey koncern yu for dis life.
PRO 23:18 If e bi like dat, den yor future go dey sikure.
PRO 23:19 Listin my pikin; make yu get sense and tink how yu dey live yor life.
PRO 23:20 Nor make friend with pipol wey dey drink wine too mush or chop well-well,
PRO 23:21 bikos pipol wey dey drink and chop too mush, go soon luz evritin. So, If all wetin yu dey do na to dey chop and sleep, den yu go soon start to wear rag.
PRO 23:22 Listin to yor papa; bikos without am, yu nor go dey dis world and wen yor mama don old, make yu still dey respet am.
PRO 23:23 Make yu do anytin to get wisdom, trut, undastand and good sense and if yu get dem, make yu nor sell dem, bikos dem go help yu well-well.
PRO 23:24 Good pesin papa get betta rizin to happy and e go dey happy if en pikin get wisdom.
PRO 23:25 Make yu do wetin go make yor papa and mama happy for yu, so dat yor mama nor go regret sey e born yu.
PRO 23:26 My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.
PRO 23:27 Ashawo and wimen wey dey bihave anyhow, na wiked trap dem bi.
PRO 23:28 Dem dey wait for yu like sey dem bi tif and dem don make many men sin against dia wifes.
PRO 23:29 Na who dem dey curse? Na who dey face trobol? Na who get enough? Na who dey komplain? Na who sore full en body? Na who nor dey fit si well?
PRO 23:30 Na doz wey dey struggol to drink wine and doz wey dey waka dey find new wine to drink.
PRO 23:31 So, make yu nor allow wine tempt yu, even doh e red well-well or dey shine for di cup and dey sweet for mout.
PRO 23:32 Bikos di next morning, e go bi like sey na snake wey get poizin, bite yu.
PRO 23:33 Yor eyes go si tins wey go sopraiz yu and yu nor go fit tink or tok well.
PRO 23:34 Yu go bi like pesin wey sleep near river or on-top boat for wota.
PRO 23:35 Yu go sey, “Dem attack mi, but I nor wound! Dem beat mi, but I nor remember. ‘Wen I go take stand up for bed, so dat I go-go find anoda drink?’ ”
PRO 24:1 Make yu nor jealous evil pipol or try to make friend with dem,
PRO 24:2 bikos na only trobol dem dey always tink about and anytin wey dem tok, dey kause wahala.
PRO 24:3 Na wisdom pesin dey take build house, but na undastandin go make am stand
PRO 24:4 and na knowledge dem take dey dekorate am with fine and betta tins.
PRO 24:5 To dey wise, betta pass to dey strong! Yes, wisdom betta pass pawa.
PRO 24:6 So make sure sey yu plan well before yu go fight and di more dem advise yu well, di more yu go dey win.
PRO 24:7 Wise word too deep for foolish pipol to undastand. So wen ever pipol dey tok about sirious matter, foolish pipol nor get any betta tin to tok put.
PRO 24:8 If yu dey always plan evil, na trobol-maker dem go dey koll yu,
PRO 24:9 bikos anytin wey foolish pesin plan, dey make pesin sin and pipol nor like pesin wey dey laf odas.
PRO 24:10 If yu faint for di day wen wahala kom, dat one go show sey yor strent small well-well.
PRO 24:11 Kwik save doz wey dem won kill for wetin dem nor do.
PRO 24:12 If yu fit sey e nor koncern yu, God know and dey judge evritin wey yu dey do. E dey look yu and E know yu well-well. E go reward yu akordin to wetin yu do.
PRO 24:13 My pikin, make yu chop honey bikos e good. Just as honey sweet for yor mout,
PRO 24:14 na so wisdom dey good for di soul. Make yu get wisdom and yor future go dey sikure.
PRO 24:15 Make yu nor bi like wiked pipol wey dey plan to tif from good pipol or break enter dia house,
PRO 24:16 bikos no matter how many times good pipol fall; dem dey always get up again; but trobol dey distroy wiked pipol.
PRO 24:17 Make yu nor dey happy if yor enemies enter trobol and nor rijoice wen dem fall,
PRO 24:18 bikos God go know if yu dey happy and E nor go like am; den E fit nor kon ponish dem again.
PRO 24:19 Make yu nor fear doz wey dey do evil and make yu nor jealous wiked pipol at-all,
PRO 24:20 bikos wiked pesin nor get betta future and dem nor dey hope for anytin again.
PRO 24:21 So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,
PRO 24:22 bikos God fit distroy dat kind pipol wons and who know di wahala wey God and di king fit kause for dem?
PRO 24:23 Wise pipol still tok dis tins too: E bad well-well if judge nor dey judge well for kourt.
PRO 24:24 If di judge sey na di pesin wey do wrong dey innocent, evribody go curse and hate am.
PRO 24:25 Judge wey dey ponish pesin wey do wrong, go prosper and get good name,
PRO 24:26 bikos, honest ansa na good sign for true friendship.
PRO 24:27 Before yu build yor house, make sure sey yu don prepare and ready yor farm for work.
PRO 24:28 Nor tok against anoda pesin without good rizin or tok yeye tins about pipol.
PRO 24:29 Nor boast sey, “I go do am back wetin e do mi. Yes! I go deal with am well-well.”
PRO 24:30 Wen I waka pass foolish and lazy pesin farm and vineyard,
PRO 24:31 na shuku-shuku and grass grow full am. Di wall wey dem build round am, don fall rish groun.
PRO 24:32 I look kon tink and I kon learn lesin from am sey:
PRO 24:33 Make yu sleep and rest as yu like or fold yor hand and rest small,
PRO 24:34 but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.
PRO 25:1 Dis na some of Solomon oda wise words and na King Hezekaya men for Judah kourt, rite dem down.
PRO 25:2 Na God get di pawa to hide tins, but na kings dey fit find and esplain dem to pipol.
PRO 25:3 Nobody fit know wetin kings dey tink. Just as sky high well-well and as sea deep rish, na so too dia mind bi.
PRO 25:4 Make yu remove dirty from silva, den yu go fit use am take make oda fine tins.
PRO 25:5 Nor let bad advisers near di king, so dat pipol go know am bikos e dey judge well.
PRO 25:6 Wen yu stand for king front, nor try to impress am or pritend sey yu bi betta pesin,
PRO 25:7 bikos e go good sey, make en ensef tell yu to sidan for high pozishon, na sey make e gi-am to anoda pesin wey dey important pass yu.
PRO 25:8 Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?
PRO 25:9 If yu and yor neighbour dey argue about sometin, e go good make una setol am between unasef and make yu nor tok about una sekret for publik.
PRO 25:10 If not, evribody go know sey yu nor fit keep sekret and yu nor go ever forget di shame wey go katch yu.
PRO 25:11 Bikos betta words wey dem tok well, bi like gold wey dem take dekorate silva.
PRO 25:12 Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.
PRO 25:13 As kold wota dey sweet for dry sizin, na so too savant wey pesin fit trust, dey make belle sweet di pesin wey send am.
PRO 25:14 Pipol wey dey promise and fail bi like kloud and heavy breeze wey nor dey bring rain.
PRO 25:15 Na patient and gentol tok, pesin dey take beg kings and na sweet mout dey setol sirious wahala.
PRO 25:16 Nor chop honey too mush bikos e sweet, so dat yu nor go vomit, bikos yu too chop am.
PRO 25:17 Make yu nor dey too visit yor neighbour, bikos dem fit taya kon hate yu.
PRO 25:18 To lie for pesin head bi like to kill pesin with swod, wound am with sharp arrow or shot am.
PRO 25:19 Like tit wey dey pain pesin or leg wey don break, na so too e bi to trust pesin wey nor dey sirious wen trobol kom.
PRO 25:20 To sing for pesin wey nor get peace for mind, bi like sey yu dey remove en klot from en body wen kold dey or rub salt put for en sore.
PRO 25:21 If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop and if e dey thirsty, make yu gi-am wota drink,
PRO 25:22 bikos as yu do like dis, yu go make shame katch am and God go reward yu.
PRO 25:23 Just as heavy breeze from nort dey bring rain, na so too aproko dey make pesin vex well-well.
PRO 25:24 E betta make yu stay on-top house, dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
PRO 25:25 To hear good news from land wey far, bi like wen pesin pour kold wota or drink for en body.
PRO 25:26 Wen good pesin listin to wetin bad pesin dey tok, e go bi like wota wey nor good or well wey get poizin.
PRO 25:27 Just as too mush honey nor good for yu, na so too, to make pipol dey praiz yu well-well, nor good.
PRO 25:28 If yu dey vex anyhow and nor fit kontrol yorsef, yu bi like town wey nor get fence at-all and wey dey eazy for enemy to attack.
PRO 26:1 Just as pipol nor dey espect rain for dry sizin, na so too, respet nor good for foolish pesin.
PRO 26:2 Just as bird dey fly pass, na so too, curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am, nor go do yu anytin.
PRO 26:3 E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin.
PRO 26:4 If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask, den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu.
PRO 26:5 Make yu ansa fool akordin to en kweshon, so dat e go know sey e nor wise as e tink, but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am.
PRO 26:6 Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.
PRO 26:7 As pesin wey en leg cripple nor fit use am, na so too foolish pipol words dey yuzles.
PRO 26:8 To praiz foolish pesin bi like to put stone for katapault kon ready to shot am.
PRO 26:9 Like shuku-shuku wey shuk drunkard man hand, na so too wise word bi for foolish pesin mout.
PRO 26:10 Like pesin wey dey shot en arrow anyhow, na so too e bi to pesin wey hire fool take work.
PRO 26:11 Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.
PRO 26:12 Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.
PRO 26:13 Lazy pesin go sey, “Lion dey for outside! Many lion dey evriwhere for di street!”
PRO 26:14 Lazy pesin go just dey turn up-and-down for bed like door handle and
PRO 26:15 some pipol too lazy to even put food for dia own mout.
PRO 26:16 Lazy pesin go tink sey en wise pass seven pipol wey get sense well-well.
PRO 26:17 Pesin wey go argue matter wey nor koncern am, bi like wen yu dey waka for road kon go hold dog for en ear.
PRO 26:18 Just as e bad for mad pesin to play with bow and arrow,
PRO 26:19 na so too e bi with pesin wey deceive en neighbour and e sey, “Nor bi joke I dey joke?”
PRO 26:20 Fire nor dey katch without wood; so without aproko, kworel nor go dey.
PRO 26:21 Pipol wey like wahala dey kause trobol, just as mashes and kerosine dey start fire.
PRO 26:22 Aproko story dey sweet some pipol well-well, but to odas, e dey pain well-well go rish dia bones.
PRO 26:23 Pesin wey get wiked heart and dey lie well-well, bi like fine klot wey dem take kover klay pot, so dat pipol go tink sey na betta tin dey der.
PRO 26:24 Pesin wey hate odas and dey pritend sey e like dem, na wikedness full en heart.
PRO 26:25 Even doh e tok sweet words, make yu nor bilive am, bikos na wikedness full en belle.
PRO 26:26 E fit hide en wikedness, but evribody go soon si di bad tins wey e dey do.
PRO 26:27 So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.
PRO 26:28 Na only pesin wey yu hate, yu go like lie against and yeye words dey distroy pipol.
PRO 27:1 Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.
PRO 27:2 So make yu let odas praiz yu, instead of yu to dey praiz yorsef.
PRO 27:3 Even doh san and stone dey heavy, e nor still heavy rish di wahala wey foolish pesin dey kause.
PRO 27:4 Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?
PRO 27:5 E betta make yu korrect pesin for open, dan to dey show am love for sekret.
PRO 27:6 If yor friend wound yu, e betta pass yor enemy kiss wey fit kill yu.
PRO 27:7 Wen pesin don beleful, even honey nor go sweet for en mout, but wen e dey hongry, even food wey bitter, dey sweet am well-well.
PRO 27:8 Anybody wey dey waka up-and-down, bi like bird wey nor dey stay en house.
PRO 27:9 Just as perfume and fine oil dey make pesin happy, na so too betta advise from pesin friend, dey bring joy to en heart.
PRO 27:10 Make yu nor forget yor friends or yor papa friends, bikos if yu dey trobol, yu nor nid to ask yor relashon for help. Di neighbour wey dey near yu, fit help yu pass yor relashon wey dey far.
PRO 27:11 My pikin, make yu dey wise and I go happy, so dat I go get good ansa to give anybody wey dey oppoz mi.
PRO 27:12 Wise pesin go si trobol dey kom kon run from am, but doz wey nor dey tink, go waka enter, den kon dey regret.
PRO 27:13 Pesin wey promise to pay money wey strenja dey owe, make una hold en propaty, especially if na ashawo e promise to pay for.
PRO 27:14 If yu shaut greet yor friend for morning, pipol go tink sey yu dey curse am.
PRO 27:15 Wife wey dey komplain well-well, bi like wota wey dey drop small-small for rainin sizin;
PRO 27:16 so how pesin go fit make am kwayet? Since pesin nor fit stop breeze or hold oil for hand, e nor go fit stop am too.
PRO 27:17 Just as iron dey make iron sharp, na so too, two pesin dey learn from each oda.
PRO 27:18 Make yu kare for yor fig tree and yu go get many fig fruit to chop and na like dis too, dem go honor savant wey dey kare for en masta.
PRO 27:19 Na yor own face dey shine for di wota wey yu dey look and na yor ownsef yu dey si for yor heart.
PRO 27:20 Just as grave nor dey taya to take dead body, na so too di tins wey pipol wont for dis world, nor dey satisfy dem.
PRO 27:21 Just as dem dey take fire test gold and silva, na so too dem dey test pesin good name.
PRO 27:22 Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.
PRO 27:23 Make yu kare for yor sheep and kattle as yu fit,
PRO 27:24 bikos money and propaty nor dey-dey forever. Even nashon nor dey last forever.
PRO 27:25 Wen grass die, new ones go appear and di plants for mountins go grow again,
PRO 27:26 den yor sheep hair go bi yor klot, yu go sell some goat wey dey yor field
PRO 27:27 and yu go get plenty goat milk to take feed yu, yor family and yor wimen savant.
PRO 28:1 Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am, but honest pesin dey get heart like lion.
PRO 28:2 Wen pipol dey always sin, dia kountry go get many leaders, but pesin wey get sense and dey undastand tins well, dey bring peace.
PRO 28:3 Poor man wey dey opress oda poor pipol, bi like strong rain wey dey skata wetin pesin plant.
PRO 28:4 So pesin wey nor dey respet di law, dey praiz wiked pipol, but doz wey dey obey di law, nor like wikedness.
PRO 28:5 Evil pipol nor know wetin korrect judgement mean, but doz wey dey woship God, undastand am well-well.
PRO 28:6 E betta to dey poor and honest, dan to dey rish and dey do wayo.
PRO 28:7 Yong man wey dey obey di law get sense. Pesin wey dey make friends with yeye pipol na disgrace to en papa.
PRO 28:8 If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.
PRO 28:9 If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers.
PRO 28:10 If yu deceive honest pesin kon make am do bad tins, yu go fall enter di trap wey yu dig by yorsef, but God go reward innocent pipol well-well.
PRO 28:11 Rish pipol dey always tink sey dem wise, but poor pesin wey get betta karata, know di rite tin.
PRO 28:12 Wen good pipol dey rule, evribody dey happy, but wen bad pipol dey rule, evribody dey hide.
PRO 28:13 Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.
PRO 28:14 If yu always dey obey God, happiness go follow yu, but yu go distroy yor life if yu dey sturbon.
PRO 28:15 Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear, na so too poor pipol nor fit fight wiked ruler.
PRO 28:16 Ruler wey nor get betta sense, go rule with wikedness. But pesin wey nor like lie, go rule tey.
PRO 28:17 Pesin wey kill anoda pesin dey kwik-kwik dig en own grave, so make yu nor try to stop am.
PRO 28:18 Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.
PRO 28:19 Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem.
PRO 28:20 Pesin wey dey tok trut, go live betta and happy life, but dem go ponish yu, if yu dey hurry to get money.
PRO 28:21 To dey judge anyhow nor good, but some judge dey lie for kourt, bikos of di small bribe wey dem won kollect.
PRO 28:22 Pesin wey get long-trot dey always hurry to get money, sotey e nor dey know wen poverty dey kom meet am.
PRO 28:23 If yu korrect pesin, e go like am pass wen yu praiz am.
PRO 28:24 Pesin wey tink sey e nor bad to tif from en papa and mama, nor betta pass ordinary tif.
PRO 28:25 To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
PRO 28:26 Pesin wey feel sey na only en know di korrect tin, na big fool, but pesin wey dey waka with wisdom, go dey save.
PRO 28:27 Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack, but if yu nor dey sorry for poor pipol, dem go curse yu.
PRO 28:28 Pipol dey hide wen wiked pesin dey rule, but wen e nor dey again, raitious pipol go prosper.
PRO 29:1 If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.
PRO 29:2 Make yu show mi good ruler and I go show yu happy pipol. Make yu show mi wiked ruler and I go show yu pipol wey dey komplain.
PRO 29:3 If yu value wisdom, yor papa go dey proud of yu, but na foolish tin to spend money for ashawo.
PRO 29:4 With betta judgement, king dey make en kingdom strong, but king wey like money well-well, dey skata en throne.
PRO 29:5 Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem.
PRO 29:6 Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.
PRO 29:7 Good pesin know wetin bi poor pipol own, but wiked pipol nor fit undastand tins like dat.
PRO 29:8 Pipol wey nor get respet for odas, go fit kause konfushon for di whole town, but wise pipol dey keep tins to demsef.
PRO 29:9 Wen wise pesin take foolish pesin go kourt, di foolish pesin go only dey shaut and tok anyhow, but e nor go dey happy.
PRO 29:10 Pipol wey dey kill pipol nor like anybody wey dey tok trut, but good pipol go protet di pesin life.
PRO 29:11 Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef.
PRO 29:12 If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins.
PRO 29:13 Just as God give eye to poor pesin, na so too E give eye to pesin wey dey opress oda pipol.
PRO 29:14 If king dey defend poor pipol, e go rule tey well-well.
PRO 29:15 To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.
PRO 29:16 Wen wiked pipol dey rule, many bad-bad tins dey inkrease, but good pipol go dey alive to si di way doz wiked pipol go take fall.
PRO 29:17 Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all.
PRO 29:18 Wen pipol nor follow God way, dem dey waka anyhow, but pipol wey dey obey God law, na happiness bi dia own!
PRO 29:19 Pesin nor fit korrect en savant with just ordinary word, bikos even doh dem undastand am, dem nor go do wetin e tok.
PRO 29:20 Yu don si pesin wey dey tok anyhow? Even fools get hope pass am.
PRO 29:21 If yu give yor savant evritin wey dem wont from small kom, one day, dem go take evritin wey yu get.
PRO 29:22 Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.
PRO 29:23 Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.
PRO 29:24 Pesin wey bi tif patina nor like en life, bikos even doh e know di trut, e don swear sey e nor go tok.
PRO 29:25 E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.
PRO 29:26 Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement.
PRO 29:27 Good pipol nor like doz wey dey do wiked tins and wiked pipol nor like good pipol.
PRO 30:1 Dis na wetin Agur wey bi Jakeh pikin tell Itiel, Ukal and Itiel:
PRO 30:2 “I dey foolish pass any oda man and I nor get sense like oda pipol.
PRO 30:3 I neva learn how to get wisdom and I nor know anytin about God.
PRO 30:4 Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!
PRO 30:5 “Evritin wey God tok, dey korrect. E dey guide evribody wey kom meet am make E protet dem.
PRO 30:6 Make yu nor add join God word, if not, E go curse and koll yu lie-lie pesin.
PRO 30:7 “My God, I beg Yu for two tins and make Yu give dem to mi, before I die.
PRO 30:8 Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.
PRO 30:9 Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.
PRO 30:10 “Make yu nor ever spoil worker give en oga, bikos if di pesin curse yu, di curse go follow yu forever.
PRO 30:11 “Some pipol dey curse dia papa and some nor dey tank dia mama.
PRO 30:12 “Dem bilive sey dem dey good for dia own eye, but dem dirty pass rag.
PRO 30:13 “Dem dey karry body as dem dey waka, so dat pipol go dey look dem anyhow.
PRO 30:14 “Dia tit bi like swod and dia mout sharp like knife. Dem dey distroy poor pipol komot from dis eart and pipol wey nor get food to chop, dem dey kill dem trowey.
PRO 30:15 “Worm get two side wey dey sey: ‘Give mi, Give mi.’ “E get three tins wey nor dey beleful at-all and di fourt one nor dey ever sey: ‘E don do or e don rish.’ Dem bi:
PRO 30:16 “Grave, belle wey neva karry pikin, wildaness wey dry and fire wey dey burn well-well.
PRO 30:17 “Di mout wey dey laf en papa and nor dey obey en mama kommand, bird from valley go plok am komot and vulture go chop am finish.
PRO 30:18 “E get four tins wey dey hard mi well-well to undastand and dem bi:
PRO 30:19 “ ‘How eagle take dey fly high-high for sky? How snake take dey waka for rock? How ship take dey move for river and how man take dey love woman?’
PRO 30:20 “Ashawo woman wey sleep with anoda man fit kill pesin, afta e go klean en mout kon sey, ‘Na wish bad tin I do?’
PRO 30:21 “E get four tins wey dey shake di eart and make pipol fear and dem bi:
PRO 30:22 “ ‘Savant wey turn to king; fool wey leta get money well-well;
PRO 30:23 woman wey pipol nor like wey kon marry and savant girl wey kon take en madam pozishon.’
PRO 30:24 “E get four tins for eart wey small, but dem wise well-well and dem bi:
PRO 30:25 “ ‘Ants; dem nor strong, but dem dey keep food wait dry sizin.
PRO 30:26 Even small animals wey dey stay for rock, dem nor get pawa, but dem dey build dia house for hole inside di rock.
PRO 30:27 Lokust; dem nor get king, but dem dey mash togeda.
PRO 30:28 Lizard, dem dey eazy to katch, but dem even dey stay for king palis.’
PRO 30:29 “E get four tins wey dey waka with pride and dem bi:
PRO 30:30 “ ‘Lion wey bi animals king wey nor dey run for anytin.
PRO 30:31 Man fawol and man goat wey dey lead di odas and king wey en sojas surround am.’
PRO 30:32 “If yu don do foolish tins bikos yu dey proud or dey plan evil, make yu kover yor mout with shame.
PRO 30:33 Just as cream dey bring butter wen dem shake am and nose wey dem nak dey bring blood, na so too, to make pesin vex, dey kause wahala.”
PRO 31:1 Na di words wey King Lemuel mama tish am, bi dis.
PRO 31:2 My pikin wey I born; my son wey I dedikate give God,
PRO 31:3 make yu nor waste yor strent dey follow wimen; bikos dem dey distroy kings.
PRO 31:4 Lemuel, my pikin! E nor good make king dey drink wine and make rulers too, nor dey take strong drink.
PRO 31:5 Bikos wen dem drink, dem fit forget di laws kon dey opress poor pipol.
PRO 31:6 Strong drink na for pipol wey dey won die and wine na for doz wey dia heart heavy.
PRO 31:7 So allow dem drink forget dia poverty and dem nor go remember dia trobol again.
PRO 31:8 Make yu tok for doz wey nor fit tok for demsef; make yu judge well for doz wey dem dey opress.
PRO 31:9 Yes! Tok well for doz wey dem dey opress and for poor pipol, den make sure sey dem give dem korrect judgement.
PRO 31:10 Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold.
PRO 31:11 En husband go trust am, bikos di wife go support am for evritin wey e dey do.
PRO 31:12 Na only good tins e go bring for en husband evritime and bad tins nor dey join.
PRO 31:13 E dey always dey do business; e dey make wool and linen klot.
PRO 31:14 E bi like ship for river, wey dey karry food kom from far place.
PRO 31:15 E dey kwik wake-up for morning to make food for en family kon tell en savants wetin dem go do.
PRO 31:16 E go-go look land kon buy am and e go use di money wey e get, take plant tins for der.
PRO 31:17 E get pawa, dey strong and dey work hard.
PRO 31:18 E know di value for evritin wey e dey make and e dey work go rish nite.
PRO 31:19 Na only en dey use tread and nidol take sew en own klot.
PRO 31:20 E dey always give tins to poor pipol and to doz wey know get at-all.
PRO 31:21 E nor dey worry if kold dey, bikos en family get klot wey go make dem warm.
PRO 31:22 Na en dey make en own bed shit and e dey wear fine klot wey dem make with purpol linen.
PRO 31:23 Pipol know en husband well-well and dem dey respet am, bikos e dey sidan with di oda eldas, dey take decision.
PRO 31:24 E dey make klot and belt kon sell dem give tradas.
PRO 31:25 E dey strong; dem dey respet am and e nor dey fear wetin go happen for future.
PRO 31:26 E dey tok with betta sense and wisdom full en mout.
PRO 31:27 E always dey busy and e dey make sure sey evritin go well for en family.
PRO 31:28 En shidren value am and dem dey tank en and en husband. Dem dey always praiz am.
PRO 31:29 En husband go sey, “Many wimen na good wifes to dia husband, but yu betta pass all of dem.”
PRO 31:30 Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear, but make pipol praiz woman wey dey honor and fear God.
PRO 31:31 Make una reward am for evritin wey e dey do and evribody must praiz am for di town.
ECC 1:1 Na King David pikin, Solomon, wey dey rule Jerusalem, rite dis words.
ECC 1:2 Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!”
ECC 1:3 Wetin pipol dey gain from all di hard work wey dem dey do for dis world?
ECC 1:4 Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go, but di world nor dey shange.
ECC 1:5 Di sun dey raiz-up and down, den e go hurry go anoda place where e go for raiz again.
ECC 1:6 Breeze dey blow go sout and nort. Yes! E dey blow round like circol.
ECC 1:7 Even as wota dey flow enter sea rish, di sea nor dey ever full, bikos, na from where di wota from kom, na der dem go rush go again.
ECC 1:8 All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
ECC 1:9 Wetin don happen before, go happen again and wetin pipol don do before, dem go do am again, bikos nor-tin dey new for dis world.
ECC 1:10 E get anytin for dis world wey fit make pesin sey, “Kom si o-o! Dis one neva happen before o-o”? But di trut bi sey, e don happen even before dem born us.
ECC 1:11 Wi nor dey remember wetin don happen before and for di next generashon, nobody go remember wetin wi dey do naw.
ECC 1:12 Mi wey dey tish una, I bi king for Israel and I stay for Jerusalem
ECC 1:13 and I make up my mind to search and undastand evritin wey pipol don do for dis world. But I kon si sey, God don really give us betta work to do for dis world.
ECC 1:14 As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.
ECC 1:15 Wetin bend, wi nor go fit strait am and wetin nor dey, wi nor go fit provide am.
ECC 1:16 Den I tell mysef, “Na mi wise pass evry oda king wey don rule for Jerusalem before mi. Bikos I get wisdom and undastandin wey dem nor get.”
ECC 1:17 So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,
ECC 1:18 bikos di more I dey find out, di more e dey worry mi well-well, bikos plenty wisdom dey bring plenty wahala too. So di more yu know, di more yu dey kause wahala for yorsef.
ECC 2:1 I tell mysef, “Make yu go enjoy yorsef, so dat yu go know wetin happiness bi” But I kon si sey, dat one too, dey yuzles.
ECC 2:2 I still si sey, “E dey foolish to dey laf anyhow and to dey find enjoyment waka, nor dey make pesin get any betta tin!”
ECC 2:3 I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.
ECC 2:4 I make wetin I get plenty; build big-big house for mysef kon plant vineyards for evriwhere.
ECC 2:5 I design fine gardin and parks for mysef kon plant difren-difren fruits for der.
ECC 2:6 I dig where wota go for dey flow for di gardin, so dat di tree dem go grow well.
ECC 2:7 I hire both men and wimen savant and I still get savants wey dem born for my house. My animal and di pipol wey dey kare for dem, many pass any of di kings own wey don rule for Jerusalem before naw.
ECC 2:8 Silva, golds and oda good tins wey I karry from oda kings and nashons, I still save dem for mysef. I hire good singas, both men and wimen and I get many fine-fine girl-friends. Yes! I get evritin wey suppose make man happy!
ECC 2:9 So I get money and propaty pass all di kings wey don rule Jerusalem before mi, plus all dis tins, I still get betta wisdom.
ECC 2:10 I dey get anytin wey I wont and I nor stop mysef from anytin wey go make mi happy. I dey proud for evritin wey I don work for and na all dis, bi my reward.
ECC 2:11 But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.
ECC 2:12 So I kon sey, make I try know di difrence between wisdom and foolishness. Abi e get anytin wey who take-ova from mi won do, wey I nor do before.
ECC 2:13 I don si sey, just as lite betta pass darkness, na so too, to know sometin, betta pass foolishness.
ECC 2:14 Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.
ECC 2:15 So I tell mysef, “Na wetin go happen to fools, go still happen to mi! Both of us go still die! So wetin I kon gain with all dis wisdom wey I get?” So I kry kon tell mysef, “E nor get any good tin wey wisdom dey give!”
ECC 2:16 Bikos both wise and foolish man, go die and time dey kom wen dem nor go remember di wise pesin just as dem nor go remember di foolish pesin again! So one day, pipol go forget di two of dem.
ECC 2:17 So, I hate dis life, bikos evritin wey dey inside, dey give trobol. Evritin dey yuzles and e bi like wen pesin dey porshu breeze.
ECC 2:18 I hate all di hard work wey I don do for dis world, bikos evritin wey I don sofa for, I go die leave dem for anoda pesin to enjoy.
ECC 2:19 And who go fit know weda di one wey go kom afta mi go dey wise or foolish? But dem go kontrol evritin wey I work for, for dis world! So, make una si as evritin dey yuzles!
ECC 2:20 So I kon regret sey, I too work hard for dis world.
ECC 2:21 Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.
ECC 2:22 So wetin pipol go gain for dis life afta all dia hard work and trobol?
ECC 2:23 As far as yu dey alive, evritin wey yu dey do, nor dey bring anytin escept pain and trobol and yu nor go even fit rest well for nite. All dis tins dey yuzles!
ECC 2:24 So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God.
ECC 2:25 Bikos nobody go fit chop, drink and enjoy anytin, escept na God gi-am.
ECC 2:26 God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
ECC 3:1 Evritin wey dey happen for dis world, dey happen for di rite time wey God wont make e happen.
ECC 3:2 Time dey to born and time dey to die; time dey to plant sometin and time dey to harvest wetin yu plant.
ECC 3:3 Time dey to kill and time dey to heal pesin; time dey to skata and time dey to build.
ECC 3:4 Time dey to kry and time dey to laf; time dey to mourn and time dey to dance.
ECC 3:5 Time dey to skata stones and time dey to gada dem again; time dey to embrace pesin and time dey not to embrace pesin.
ECC 3:6 Time dey to find sometin and time dey to stop to find; time dey to keep sometin and time dey to trowey tins.
ECC 3:7 Time dey to tear klot and time dey to sew; time dey to just dey kwayet and time dey to tok.
ECC 3:8 Time dey to love pesin and time dey to hate pesin too; time dey to fight war and time dey to make peace.
ECC 3:9 So, wetin pipol really dey gain for all di hard work wey dem do?
ECC 3:10 I don si di heavy work wey God give us en pipol, so dat wi go dey busy.
ECC 3:11 God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.
ECC 3:12 So I gri sey, e nor get anytin wey betta rish to dey happy and enjoy yorsef as far as yu dey alive.
ECC 3:13 So, make pipol chop, drink and enjoy wetin dem work for, bikos all dis tins na God gift.
ECC 3:14 Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.
ECC 3:15 Wetin dey happen naw, don happen before and wetin go happen for future don still happen before, bikos God dey make di same tin happen again and again.
ECC 3:16 I still si sey, for dis world, yu go si wikedness for where good judgement and rite pipol suppose dey.
ECC 3:17 Den I tell mysef, “E nor go tey before God go judge evribody, bikos of evritin wey dem don do! Both good and bad pipol.”
ECC 3:18 I still sey, “God dey do all dis tins bikos of us, so dat wi go know sey wi nor betta pass animals.”
ECC 3:19 Na di same tin go happen to pipol and animal; di two of dem must die. So pipol nor betta pass animal. Dis tin dey yuzles too.
ECC 3:20 Di two of dem dey waka go di same place and bikos God kreate dem with san, wen dem die, dem go turn to san again.
ECC 3:21 Who go fit show sey, wen pesin die, en spirit dey go up, but wen animal die, na groun en spirit dey go?
ECC 3:22 So I si sey, di best tin to do as human being, na to enjoy wetin wi don work for. Dat na di rizin why wi dey here, bikos nobody go fit bring us kom enjoy life again afta wi don die.
ECC 4:1 Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.
ECC 4:2 So I sey, e betta well-well for pipol wey don die, pass doz wey still dey alive.
ECC 4:3 But di ones wey dia own betta pass, na shidren wey dem neva born, bikos dem neva si all di wiked tins wey dey happen for dis world.
ECC 4:4 Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
ECC 4:5 Foolish pesin dey fold en hand and nor dey work, so e nor get anytin to chop, escept en own flesh.
ECC 4:6 E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
ECC 4:7 I still notis anoda tin for life wey dey yuzles.
ECC 4:8 E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!
ECC 4:9 Two pipol betta pass one pesin, bikos dem get betta reward for dia work.
ECC 4:10 Bikos if one pesin fall, di oda pesin go help am stand. But pesin wey dey alone, e go bad well-well for am wen e fall.
ECC 4:11 Na so too, wen two pipol sleep togeda, dem go fit make each oda body warm, but na how one pesin fit take make ensef warm?
ECC 4:12 Dem fit attack and win one pesin wey stand alone, but two pipol go stand fight kon win. Na three pesin even betta pass, bikos e dey hard to kut three rope wey dem tie togeda.
ECC 4:13 E betta make yu dey poor and wise as youth, dan to bi old foolish king wey nor dey take advise.
ECC 4:14 Even if dem born dat youth for poor house or if e dey prison since, e fit kom out kon bi king for en town.
ECC 4:15 I don si for dis world as evribody dey follow one yong man wey dey lead dem afta di king die.
ECC 4:16 Even doh many pipol dey support am naw, anoda generashon go grow kon rijet am leta. So yu si, evritin dey yuzles and e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
ECC 5:1 Make yu dey kareful wen yu enter God temple, bikos to kom meet God make E tish yu, betta pass foolish sakrifice and pipol wey dey offa am, nor know sey wetin dem dey do, nor good.
ECC 5:2 Make yu tink well-well before yu tok or before yu make promise give God. God dey heaven and yu dey dis eart, so make yu nor dey tok too mush.
ECC 5:3 Too mush tinkin dey kause bad dream and di more yu tok, di more yu go dey tok like fool.
ECC 5:4 Wen yu promise God sometin, make yu do am kwik-kwik, bikos E nor get anytin to do with fools. So make yu do wetin yu promise.
ECC 5:5 E betta make yu nor promise dan to make promise wey yu nor go fit keep or pay.
ECC 5:6 Nor allow yor mout make yu sin and nor go defend yorsef give pastor sey, “Na mistake I take make di promise.” Dat kind tin go make God vex for yu and E fit distroy evritin wey yu don work for!
ECC 5:7 Bikos many dreams and tok-tok nor mean anytin, so make yu dey fear God.
ECC 5:8 Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.
ECC 5:9 Na evribody dey enjoy wetin di land dey produce; even king dey put hope for wetin dem harvest from farm.
ECC 5:10 Pipol wey like money, even di one wey dem get, nor dey rish dem and doz wey like propaty, wetin dem get, nor dey rish dem too. Dis kind behaviour dey yuzles too.
ECC 5:11 Di more yu get, di more pipol go kom help yu spend am; di only gain for inside, na sey yu get money.
ECC 5:12 Pipol wey dey work hard, dey sleep well for nite; weda dem chop small or plenty food. But pipol wey too rish, nor dey even fit sleep at-all.
ECC 5:13 E get anoda sirious problem wey I don si for dis world. Pesin money fit bring wahala for am.
ECC 5:14 E go put am for bad business kon luz evritin. For di end, nor-tin remain to leave for en shidren.
ECC 5:15 Just as pesin kom out from en mama belle naked, na so too e go-go back naked and e nor go karry anytin follow body.
ECC 5:16 Dis one too na anoda sirious problem. Just as pesin take kom, na so too e go take go back. And dia hard work na for nor-tin, e just bi like wen yu dey try to katch breeze.
ECC 5:17 Wen e dey alive, na darkness e for dey chop and na pain and sickness full en body.
ECC 5:18 I still don notis one tin, at least, dis one dey good: E good for pipol to chop, drink and enjoy dia work for di short time wey God give dem to live dia life, bikos na so God wont am.
ECC 5:19 E still good wen God bless yu with money, propaty and good health wey yu go take enjoy dem. To enjoy yor work and asept di life wey God give yu, na big gift from God.
ECC 5:20 God dey always make dat kind pesin enjoy en life and e nor dey worry about anytin.
ECC 6:1 E get anoda sirious tin wey I don still si for dis world and e dey show for pipol life.
ECC 6:2 God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.
ECC 6:3 If pesin get hundred shidren and e stay for dis life kon old, but if e nor get happiness and dem nor do betta beri for am, den I go sey, “Pikin wey dem just born and e die, betta pass am.”
ECC 6:4 E for betta sey dem nor born dat pikin, bikos en life disappear enter darkness. E nor even get name.
ECC 6:5 E nor ever si day lite or know wetin life bi, but at least, e get rest
ECC 6:6 pass di man wey stay 2,000 years for dis world and e nor ever enjoy am. Afta all, di two of dem dey go di same place.
ECC 6:7 Pipol dey work just bikos of wetin dem go chop, but dem still nor dey beleful.
ECC 6:8 So, how wise pipol take betta pass pipol wey bi fool? Poor pesin wey sabi work well-well, wetin e go gain for dis life?
ECC 6:9 So, make yu enjoy wetin yu get, instead of wetin yu wont and stop to dream of tins wey dey yuzles, like pesin wey dey porshu breeze.
ECC 6:10 Evritin wey dey happen, na wetin God don sey go happen and all of us know sey, yu nor go fit argue with pesin wey strong pass yu.
ECC 6:11 Bikos di more pesin dey argue, di more en word nor dey mean anytin, so how dat one go take benefit anybody?
ECC 6:12 Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?
ECC 7:1 To get good name betta pass perfume wey dear well-well and di day wen pesin die, betta pass di day wen dem born am.
ECC 7:2 E betta to go house where dem for dey kry dan to go where dem for dey celebrate; bikos evribody go die one day. So make pipol wey still dey alive put dis one for dia mind.
ECC 7:3 E betta make pesin dey tink about life, dan sey e dey laf anyhow. Bikos to dey tink and dey kwayet, good well-well for di heart.
ECC 7:4 Pesin wey always dey tink about happiness, na fool, but pesin wey get sense, go still dey tink about deat too.
ECC 7:5 E betta make wise pesin korrect yu dan make fool praiz yu.
ECC 7:6 Bikos just as shuku-shuku dey burn for fire, na so fool life bi. Dis one too dey yuzles.
ECC 7:7 True-true, opreshon fit turn wise man to fool, just as bribe dey korrupt di mind.
ECC 7:8 To finish anytin wey yu start, betta pass wen yu start am, just as to dey patient betta pass to dey proud.
ECC 7:9 Always dey kontrol yor tempa, bikos vexnashon go turn yu to fool.
ECC 7:10 Nor ever ask, “Wetin make evritin bad dis days pass as dem bi before?” Bikos e nor dey wise to ask dat kind kweshon.
ECC 7:11 Wisdom dey sweet well-well wen money dey, bikos both wisdom and money dey good well-well for dis life.
ECC 7:12 Wisdom and money fit give yu anytin wey yu wont for life, but na only wisdom fit save yor life.
ECC 7:13 Make yu asept di way God kreate tins; abi e get who go fit strait wetin God don bend?
ECC 7:14 Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am, but wen sofa kom, make yu know sey e still kom from God too, bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.
ECC 7:15 I don si evritin for dis yuzles life; good yong pipol wey kwik die before dia time and wiked pipol wey dey get long life.
ECC 7:16 So make yu nor dey too good or too wise, if not e go distroy yu!
ECC 7:17 Make yu nor dey too wiked or bihave like fool, if not, yu fit die before yor time!
ECC 7:18 But make yu listin to all dis warnin, bikos anybody wey dey fear God, go dey save.
ECC 7:19 Pesin wey wise, strong pass ten pipol wey dey rule di town,
ECC 7:20 bikos e nor get anybody for dis world wey dey good well-well and nor dey sin.
ECC 7:21 So, make yu nor listin to wetin pipol dey tok, if not, yu go hear yor savant dey curse yu,
ECC 7:22 bikos yu know for yor own heart too, how many times yusef don curse oda pipol.
ECC 7:23 I dey always try my best make wisdom guide wetin I dey tink and evritin wey I dey do. Den I tell mysef, “I dey ready to learn” but I nor fit undastand am at-all.
ECC 7:24 Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand; dem too deep for us to tink about.
ECC 7:25 So I try to search evriwhere to get wisdom and to undastand why tins dey happen di way dem dey happen and I dey ready to prove to mysef sey, wikedness dey stupid and foolishness dey bring madness.
ECC 7:26 I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.
ECC 7:27 Di Tisha sey: “I undastand all dis tins wen I dey try to look for ansa to evritin.
ECC 7:28 “Wetin I dey find since, I neva still si am; I si sey among 1,000 pipol, na only one man dey good, but I nor si any woman wey good among dem.
ECC 7:29 But I still learn dis one too: God kreate evribody make dem dey good, but dem don dey do wiked tins as dem like.”
ECC 8:1 Na who wise and get sense? Na Who know di ansa to dis problem? Wisdom dey make pesin smile and remove vexnashon from en face.
ECC 8:2 So since yu don promise God sey yu go dey loyal to am, den make yu obey di king kommand.
ECC 8:3 Make yu nor rush komot from di king present; nor put yor hand for bad tin, bikos di king fit do anytin wey e like.
ECC 8:4 Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.
ECC 8:5 Di king nor go ponish pesin wey dey obey am and doz wey dey wise, go find di way and time to do wetin dey good.
ECC 8:6 E get time and how to do tins; bikos di king ponishment dey strong well-well.
ECC 8:7 True-true, nobody know tumoro and nobody fit tell anoda pesin wetin go happen tumoro.
ECC 8:8 Wi nor fit kontrol breeze or tok di day wen wi go die. Dat na one war wey wi nor fit run from and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.
ECC 8:9 All dis tins wey dey happen for dis world, I don tink about dem well-well kon si sey time dey for pesin to opress en neighbour as e like.
ECC 8:10 I si as dem beri wiked pipol with honor, but God pipol dey komot di holy town and pipol dey forget dem. All dis tins nor make sense at-all.
ECC 8:11 Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.
ECC 8:12 If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass.
ECC 8:13 But wiked pipol nor go prosper, bikos dem nor dey fear God. Dia life go kwik finish like pesin shadow.
ECC 8:14 E still get oda yuzles tins for dis world: Sometaims, wi dey trit good pipol like sey dem wiked, den trit wiked pipol like sey dem dey good and na dis dey yuzles pass.
ECC 8:15 So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.
ECC 8:16 But for day and nite, I nor dey sleep bikos I dey try to undastand wetin dey happen for dis world.
ECC 8:17 I notis sey nobody go fit know evritin wey God dey do for dis world. Aldo wise pipol fit klaim sey dem know, but dem nor know anytin at-all.
ECC 9:1 So as I sidan dey tink dis tins make I for undastand dem, I kon si sey, na God dey kontrol evritin wey raitious and wise pipol dey do. Even doh wi like or hate anytin, nobody know wetin go happen for future.
ECC 9:2 Weda wi dey raitious or wiked; good or bad; dey klean or not; dey offa sakrifice or not, na di same tin go happen to all of us, bikos pesin wey good nor betta pass sina and pipol wey dey make promise give God, nor betta pass doz wey nor dey make.
ECC 9:3 Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
ECC 9:4 But doz wey dey alive get hope, bikos dog wey dey alive, betta pass lion wey don die!
ECC 9:5 Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.
ECC 9:6 Evritin wey dem do wen dem still dey alive, weda dem love, hate or bin dey jealous pesin, all don die follow dem go. Dem nor get part for anytin wey dey happen for dis world again.
ECC 9:7 So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.
ECC 9:8 Make wi always let awa klot dey klean and spray betta perfume for body!
ECC 9:9 So as far as wi dey live dis yuzles life wey God give us, make wi enjoy am with awa wife, bikos dat na awa reward for all di trobol wey wi dey face for dis world.
ECC 9:10 So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
ECC 9:11 I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.
ECC 9:12 True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.
ECC 9:13 Dis na anoda tin wey I don si about wisdom and I like am, bikos of di way tins dey happen for dis world.
ECC 9:14 E get one town and di pipol wey dey inside nor many. Den one king wey get pawa well-well bring en sojas kon attack dem.
ECC 9:15 But one poor wise man for der, know wetin to do, so dat di town go dey save. So e do am kon save evribody. But afta, nobody tink am for dia heart sey, make dem tank di man.
ECC 9:16 So I kon si sey, wisdom betta pass pawa, but nobody go respet wise man wey poor; nobody go gri listin to en advise bikos e nor get money.
ECC 9:17 Wise pipol nor dey shaut wen dem dey tok and dis betta pass king wey dey shaut and tok to fools.
ECC 9:18 So wisdom dey good pass swod, but one sin fit distroy many-many good tins.
ECC 10:1 Just as fly wey don die dey make perfume smell, na so too small foolishness dey spoil pesin wisdom and respet.
ECC 10:2 Wise man sense dey protet am, but di sense wey fools get, dey put dem for wahala
ECC 10:3 and even wen foolish pesin dey waka for road, e dey know and show evribody sey e bi fool!
ECC 10:4 If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.
ECC 10:5 E get anoda bad tin wey I don si for dis world and na big mistake wey kings dey make,
ECC 10:6 bikos dem go give betta pozishon to fools kon put wise pipol for di yeye ones.
ECC 10:7 I don even si where savant dey ride horse like sey e bi prince, while prince dey waka like sey e bi savant!
ECC 10:8 Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.
ECC 10:9 Anybody wey dey work for where dem dey kut stones, di stones fit fall press am. If yu dey kut wood, di axe fit still wound yu too.
ECC 10:10 Yu go nid to use more pawa take kut wood if di axe wey yu dey use nor sharp, so make yu sharp di axe well. Dis na di value wey dey wisdom and e go help yu susid.
ECC 10:11 If snake bite pesin before dem sharm am, den e nor get nid to koll di pesin wey dey sharm snake.
ECC 10:12 Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,
ECC 10:13 and na only yeye tins fools dey tok and na madness dey end am,
ECC 10:14 bikos dem go just dey tok anyhow waka. So, nobody really know wetin go happen naw or di ones wey go happen for future.
ECC 10:15 Foolish pesin work dey kwik taya am, bikos e nor even know road to follow go en house.
ECC 10:16 E go bad for any town wey dia king dey tink like small pikin and dia leaders dey always do party till day break.
ECC 10:17 Kountry wey en king get betta karata, wey en leaders dey chop for di rite time, so dat dem go get pawa and nor dey drink anyhow, na blessing go follow dem.
ECC 10:18 Na so too, wen pesin too lazy to ripair en house, wen en zink dey leak, di house go fall.
ECC 10:19 Party na to make pesin happy and to dey drink wine dey bring joy, but na money dey ansa evritin!
ECC 10:20 Make yu nor curse di king for yor mind or curse rish pipol for yor room, bikos one small bird fit karry wetin yu dey tok and tink, go tell dem.
ECC 11:1 Put yor money for betta business and e nor go tey before yu go bigin gain am.
ECC 11:2 But e betta if yu put am for many business, bikos yu nor know where wahala go from kom.
ECC 11:3 If wota full di kloud, den rain must surely fall for di eart and weda tree fall go nort or sout, di tree must stay for where e fall put.
ECC 11:4 Any farmer wey dey wait for betta weda, nor go ever plant seed and if e dey look di kloud to know weda rain go fall, e nor go ever harvest wetin e plant.
ECC 11:5 Just as yu nor go fit undastand how breeze dey blow or how pikin take dey grow for en mama belle, na so too yu nor go fit undastand how God take make evritin.
ECC 11:6 So, make yu go plant yor seed for morning and nor stop to work until evening; bikos yu nor know di one wey yu do wey go bring gain for yu; weda na dis one, dat one or di two.
ECC 11:7 Lite sweet well-well and e dey good to si anoda new day.
ECC 11:8 So if pesin get long life, make e dey happy as e dey live di life. But make e still know sey, di days wey darkness go dey, many well-well and evritin wey go still happen, dey yuzles.
ECC 11:9 Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.
ECC 11:10 So, anytin wey go make yu sin, make yu remove dem from yor mind, so dat yor body go dey strong, bikos yong life na for enjoyment. But remember sey yu nor go yong forever o-o.
ECC 12:1 So, make yu remember and honor di Pesin wey kreate yu naw wen yu still dey yong, bikos wen yu don old, yu go sey, “Life nor sweet again.”
ECC 12:2 Remember am before di sun, moon and stars go dark and before kloud disappear wen rain don fall finish.
ECC 12:3 Remember am before doz wey dey guide yor house bigin shake with fear. Dat time, yor strong men go don dey weak. Make yu remember am naw, before yor tit go pul finish and yor eyes nor go fit si well again.
ECC 12:4 Remember am naw, before life opportunity door go klose and work nois go fade komot yor ear. Naw, yu dey wake-up with bird nois, but den, all di sound go dey komot small-small from yor ear.
ECC 12:5 Remember am naw, before yu go kon dey fear to klimb high place or to waka for road; den yor hair go don turn white like almond tree wey dey shine and yu go hardli fit karry yorsef just like grasshoppa wey dey die; den all di mind to dey sleep with woman or man, go vanish and small time, yu go-go yor final resting place, den pipol go mourn for di street for yu.
ECC 12:6 Yes! Make yu remember di Pesin wey kreate yu naw wen yu dey yong, before di silva shain go kut and di gold lamp go fall break. Nor wait until di wota pot go skata or di rope for di well go kut.
ECC 12:7 By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
ECC 12:8 So di tisha sey, “Evritin dey yuzles. Yes! Dem yuzles well-well.”
ECC 12:9 Nor bi sey na only sense di tisha get, but e still dey tish di pipol how to get wisdom. E take en time take tish and show dem many proverbs.
ECC 12:10 Di tisha kon try to find good words wey go make us know di trut;
ECC 12:11 bikos word wey wise pesin tok, bi like di sharp stik wey shepad dey use and wise words bi like word wey dem nail well for wall and na God bi di Shepad wey give us all dis tins.
ECC 12:12 But my pikin, make I warn yu: nor add join dis words; bikos pipol go still dey rite many book and too mush readin, go make yu kwik old.
ECC 12:13 So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”
ECC 12:14 For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.
SOL 1:1 Dis na Solomon love song.
SOL 1:2 Yes! Make yu kiss mi well-well, bikos to sleep with yu sweet pass wine.
SOL 1:3 Si as yor perfume dey scent well-well and yor name bi like di perfume wey fine pass. No wonder wimen love yu well-well!
SOL 1:4 Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.
SOL 1:5 Jerusalem wimen, I bi black and fine woman; I black like Kedar and Solomon tents.
SOL 1:6 So make una nor dey look mi anyhow bikos sun don make my skin black. My brodas dey vex for mi, so dem kon force mi dey work for farm and bikos of dat, I nor fit kare for my body.
SOL 1:7 My love, make yu tell mi! Na where yu won go feed yor animals today? Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon? Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down like ashawo for where yor friends and dia animals dey!
SOL 1:8 My woman! Di one wey fine pass among wimen! If yu dey find mi, make yu follow my animals footstep rish where I dey kon kare for yor small goats near di shepad tent.
SOL 1:9 My love, yu bi like woman horse for where Fero man horse dem dey.
SOL 1:10 Yor face dey shine well-well, bikos of di oil wey dem take rub am and di difren shains wey yu wear, don make yor neck fine too.
SOL 1:11 So, wi go make gold ear-ring and silva beads for yu.
SOL 1:12 As di king sidan for en tabol where e for dey do party, my perfume smell kon make am dey happy.
SOL 1:13 As my love put en head on-top my breast thru-out di nite, en whole body kon dey smell like myrrh.
SOL 1:14 My love bi like Henna flower wey dey shine well-well for En-Gedi Field.
SOL 1:15 Si as my darlin fine well-well, make yu si as yu fine rish! Yor eyes bi like dove own!
SOL 1:16 Yes! Yu too fine my love and I dey happy to always dey with yu. Na di grass go bi awa bed
SOL 1:17 and na cedar wi go take design awa house kon build di roof with Cypress tree.
SOL 2:1 Na mi bi di Rose flower from Sharon, di lily flower for di valley.
SOL 2:2 Just as lily flower dey among shuku-shuku, na so my darlin bi among oda yong wimen.
SOL 2:3 Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.
SOL 2:4 E take mi go di party kon show mi as e love mi rish.
SOL 2:5 E give mi kake, so dat I go get pawa kon add apples join am, bikos en love won make mi faint.
SOL 2:6 E dey rub my head with en left hand kon dey massage mi with en rite hand.
SOL 2:7 Jerusalem wimen! Make una promise mi with animals, like deer and gazelle sey, una nor go disturb awa love.
SOL 2:8 Make una listin! My love dey kom. Si! E dey pass di mountins and di hills dey kom meet mi.
SOL 2:9 My love bi like gazelle or yong deer. Look! E stand for back of awa wall, where e for dey look di room thru di window.
SOL 2:10 My love tell mi sey, “Get up, my darlin! My fine wife, make yu kom follow mi go!
SOL 2:11 Si! Kold sizin don pass and rain nor dey fall again.
SOL 2:12 Di flowers don dey grow and di time wen birds dey sing, don kom and naw, wi dey hear dove dey sing for awa land.
SOL 2:13 Fig tree don dey bring fig fruit kom out and di breeze dey scent with fresh vines. So get up, make yu follow mi, my darlin and sweet wife; kom follow mi make wi dey go!”
SOL 2:14 Yu bi like dove wey hide inside rock, so make yu allow mi si yor fine face kon hear yor sweet vois.
SOL 2:15 Make una katch all di fox for us; especially di small-small ones, before dem go distroy awa vineyard.
SOL 2:16 My love na my own and I bi en own too; e dey feed en animals for where lilys dey.
SOL 2:17 My love, before di morning breeze go blow and darkness go disappear, make yu kom back kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top mountin.
SOL 3:1 As I sleep for my bed thru-out di nite, I find di one I love with my heart and soul, but I nor si am.
SOL 3:2 So I tell mysef, “I go get up go di town, enter di street kon follow korna-korna go find di pesin wey I love.” So I find evriwhere, but I nor still si am.
SOL 3:3 So wen I si di men wey dey guide for nite, I kon ask dem, “Una si my love?”
SOL 3:4 As I waka pass dem small, I kon si di pesin wey I love. I hold am tight and I nor wont make e go, so I take am go my mama house; to di bedroom where e for get my belle.
SOL 3:5 So Jerusalem wimen, make una promise mi with gazelle and deer sey una nor go disturb awa love.
SOL 3:6 Who dey waka kom from di desert like smoke or like incense and myrrh? Na fine incense wey dem dey sell?
SOL 3:7 Si! Na Solomon dem karry for en throne dey kom and na sixty fine sojas for Israel dey guide am.
SOL 3:8 All of dem sabi use swod well and dem train dem well to fight war. Each of dem swod dey near dia waist and dem dey guide against anybody wey won attack dem for nite.
SOL 3:9 King Solomon use Lebanon wood take make one chair for ensef.
SOL 3:10 Dem make di korna with silva kon design di back with gold. Na purpol klot dem take wrap am and na Jerusalem wimen dekorate am with leda.
SOL 3:11 So Jerusalem wimen, make una kom si King Solomon dey kom. E wear di crown wey en mama take crown am for di day wen e marry and na dat day, sweet pass for en life.
SOL 4:1 My darlin, yu too fine! I nor fit diskribe as yu fine rish. Even with di lite klot wey yu take kover face, yor eyes still dey shine like dove own. Yor hair dey dance like woman goat wey dey kom from Mount Gilead.
SOL 4:2 Yor tit dey white like sheep wey dem just barber en hair kon wosh en body klean. Yor tit komplete and all of dem mash each oda.
SOL 4:3 Yor lips bi like red klot; yor mout sweet well-well. Yor fore head for di lite klot wey yu take kover, bi like pomegranate fruit.
SOL 4:4 Yor neck fine well-well like David towa and e round and smooth and yu wear necklace wey get 1,000 tins wey dey guide am.
SOL 4:5 Yor two breast bi like gazelle or deer wey bi twins wey dey chop for where lily flower dey.
SOL 4:6 Before di morning breeze go blow and darkness go disappear, I go hurry go myrrh mountin and incense hill.
SOL 4:7 My love, yu too fine and dey pafet!
SOL 4:8 My wife to bi, make yu follow mi from Lebanon. Make yu kom down from Mount Amanah, from Senir and Hermon and where lion and leopard dey stay.
SOL 4:9 My sista and wife, yu don tif my heart! Only di way yu dey look mi and di necklace wey yu wear, don tif my heart.
SOL 4:10 My sista and wife to bi, yor love dey sweet mi for body. Yor love betta pass wine and yor perfume scent pass spices.
SOL 4:11 My wife to bi, yor lip sweet like honey, bikos honey and milk dey under yor tongue. Yor klot dey scent like cedar for Lebanon.
SOL 4:12 My sista and wife, yu bi my sekret gardin; my fine gardin wey get en own well.
SOL 4:13 Yu bi royal gardin wey pomegranate fruit and fine fruit like Hena and Nard tree, full:
SOL 4:14 Nard and saffron flower; kalamus and sinamon with difren spice, myrrh, aloe and some oda fine-fine spice, still dey der too.
SOL 4:15 Yu bi gardin wey get fountain; well wey get fresh wota wey dey kom down from Mount Lebanon.
SOL 4:16 Breeze from nort, make yu wake-up! Breeze from sout, make yu blow my gardin kon spread yor scent round am. My love, make yu kom my gardin kon taste en betta fruit.
SOL 5:1 I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
SOL 5:2 I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”
SOL 5:3 But I ansa, “I don already pul my klot, make I wear am back again? I don wosh my leg, make I dirty am again?”
SOL 5:4 My love try to open di door from outside thru di hole and I kon dey feel for am.
SOL 5:5 So, I stand won go open di door for my love, but perfume and myrrh full my hand as I dey try to open am.
SOL 5:6 I open di door for my love, but e don go! I vex well-well. I look evriwhere, but I nor si am. I koll am, but nobody ansa mi.
SOL 5:7 Di guide dem for nite si mi as dem dey waka dey guide di town wall. Dem beat, wound and remove di klot wey I take kover my face.
SOL 5:8 So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.
SOL 5:9 Woman wey fine well-well, wetin make yu tink sey yor love betta pass oda men? Wetin dey good about yor love, wey go make us promise yu?
SOL 5:10 My love fine well-well and e dey strong; e betta pass 10,000 pipol!
SOL 5:11 En hair bi like fine gold and e dey shine like black bird.
SOL 5:12 En eye dey shine like dove wey dey near spring wota; dem bi like betta gold wey dem wosh with milk.
SOL 5:13 En jaw bi like gardin wey en spices dey scent and en lip bi like flower wey dem spray myrrh put.
SOL 5:14 En hand round like gold with beryl stone and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.
SOL 5:15 En leg bi like pila wey dem design with marbol and gold; while en face bi like cedar for Lebanon.
SOL 5:16 En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.
SOL 6:1 Woman wey fine pass among oda wimen, na where yor love go? Na wish place e pass, so dat wi go help yu go find am?
SOL 6:2 My love don go en gardin; e don go where sweet spices dey. Na for der, e go feed en animals kon gada lily flowers.
SOL 6:3 I bilong to my love and e bilong to mi. E dey feed en animals among di lily flowers for di valley.
SOL 6:4 My darlin, yu fine like Tirzah town. Yes! Yu fine like Jerusalem kon sweet like di great town.
SOL 6:5 Nor look mi with yor eyes, bikos dem dey sweet mi for body. Yor hair skata like goat wey dey kom down from Gilead Mount.
SOL 6:6 Yor tit white like sheep wey dem just wosh klean; each of di tit na two dem bi and dem komplete.
SOL 6:7 Even with di lite klot wey yu take kover, yor jaw still bi like pomegranate fruit.
SOL 6:8 Even if I get sixty kweens, eighty girl-friends and many wimen around mi,
SOL 6:9 na-im bi di only one wey I love and e fine like dove. Na-im bi di only girl wey en mama born and en mama like am well-well. So evry woman dey bless am; even di kweens and my girl-friends dey praiz am.
SOL 6:10 “So, who bi dis wey appear like morning lite; wey fine like moon; dey shine like sun kon get stars like soja wey get many rank?”
SOL 6:11 I go di place where dem plant walnut tree kon from der dey fine di valley bottom so dat I go si if di plants don grow or if dem dey shine well.
SOL 6:12 But before I know, I si mysef for di royal war horse with my love.
SOL 6:13 Make yu kom back. Abeg! Make yu kwik kom back, so dat wi go fit si and look yor face again! Why una wont make dis Shullam woman dance Mahanaim style with di odas?
SOL 7:1 Fine woman! Make yu si as yor leg fine for inside sandal. Yor lap round like gold wey betta goldsmit make.
SOL 7:2 Yor pompu round like cup wey full with wine wey dem mix. Yor belle bi like many korn seed wey lily gada round.
SOL 7:3 Yor two breast bi like gazelle or deer wey bi twins.
SOL 7:4 Yor neck fine just like ivory towa and yor eyes bi like Heshbon Pool wey dey shine near Bat-Rabbim Gate. Yor nose fine like Lebanon towa wey face Damaskus.
SOL 7:5 Yor head fine like Mount Karmel. Yor hair dey shine like design wey dey di king garment. Di wey e fine, dey sopraiz di king well-well.
SOL 7:6 So my love, make yu si as yu fine rish! Yes! Yu too fine; si as love make yu komplete well-well.
SOL 7:7 Yu slim like palm tree and yor breast bi like palm fruit.
SOL 7:8 I sey, “I go klimb di tree kon plok en fruit. To mi, yor breast bi like grape and di smell from yor nose, dey scent like apple.”
SOL 7:9 So make yor mout taste like di wine wey good pass, wey go flow small-small enter awa lips wen wi dey sleep togeda.
SOL 7:10 I bilong to my love and e don take mi as en own.
SOL 7:11 My love, kom dis nite make wi go sleep on-top di flowers for di field.
SOL 7:12 Make wi wake-up for early morning go di vineyard, so dat wi go si weda di grape vine don get new leaf and if di leafs don open or if di pomegranate fruit don dey grow. And na for der I go for give yu my love.
SOL 7:13 Di mandrake fruit and di fruit wey fine pass, dey give us sweet smell. My darlin, difren kind of good tins dey awa door-mot and I don keep both old and new wons for yu.
SOL 8:1 I wish sey yu bi my broda, wey suck my mama breast. Den I for fit kiss yu, even if pesin dey look us and nobody go tok anytin.
SOL 8:2 My mama wey tish mi, I go take yu go en house. I go give yu betta wine drink. Yes! Even my sweet pomegranate wine.
SOL 8:3 Yu go rub my head with yor left hand kon massage my body with yor rite hand.
SOL 8:4 Jerusalem wimen, make una promise mi sey una nor go disturb awa love.
SOL 8:5 Who bi dis wey hold en love dey waka kom from di desert? I wake yu up from under di apple tree where yor mama for born yu. For der, yor mama dey kry with pain, wen e dey born yu.
SOL 8:6 Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.
SOL 8:7 Even strong wota nor fit kwensh love; river nor go fit swallow love. Pesin nor go fit buy love with all en propaty, bikos dem nor dey sell am.
SOL 8:8 Wi get one small sista wey neva get breast and naw, wetin wi go do, wen one yong man one marry am?
SOL 8:9 If e bi wall, wi go build towa with silva for am; but if e bi door, wi go protet am with cedar.
SOL 8:10 I bi wall before and my breast stand like towa where dem dey keep tins put, so wen ever my love look mi, e dey always dey happy, bikos of wetin e dey si for my body.
SOL 8:11 Aldo Solomon hire en vineyard give farmers for Baal-Hamon and each of dem dey gi-am 1,000 silva koin wen ever dem harvest di fruit.
SOL 8:12 But na only mi get my vineyard and Solomon nor nid to pay 1,000 silva koin. But I go give two hundred silva koin to di pipol wey dey kare for di vines.
SOL 8:13 My love, make I bi di first to hear yor vois from di gardin, bikos my friends dey wait to hear am too.
SOL 8:14 My love, make yu kwik kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top di mountin where spices for dey grow.
ISA 1:1 Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.
ISA 1:2 Heaven and eart, make una listin to wetin God tok: “Di shidren wey I train by mysef don turn against mi.
ISA 1:3 Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”
ISA 1:4 Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.
ISA 1:5 Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.
ISA 1:6 From una head go rish una leg, na sore full am. Una body don skata, bikos sore full evriwhere and dem nor bandage, klean or trit dem at-all.
ISA 1:7 Una land don skata and fire don burn una towns finish. For una front, strenjas dey distroy una plants kon skata evritin wey dem si.
ISA 1:8 Na only Jerusalem remain and e bi like one small house wey dem build for farm or for cucumber field.
ISA 1:9 If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.
ISA 1:10 So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una. Gomorrah pipol, make una put ear for wetin God dey tish una.
ISA 1:11 E sey, “Una sakrifice nor mean anytin to mi. I don taya for una animal ofrin; I nor like una goats, bull or melu blood.
ISA 1:12 Who sey make una dey bring dis animals wen una dey kom woship mi? Who sey make una dey mash round my temple?
ISA 1:13 Make una stop to bring una yuzles ofrins bikos di smell of di incense wey una dey burn, dey make mi vex. I nor wont una new moon festival; una Sabat and where una for dey gada woship mi, bikos sin don spoil all of dem.
ISA 1:14 I hate una new moon festival and di oda feast wey una dey celebrate, don taya mi. I nor fit bear dem again.
ISA 1:15 Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.
ISA 1:16 Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.
ISA 1:17 Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”
ISA 1:18 Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.
ISA 1:19 If una obey mi, una go chop di good food wey di land dey produce.
ISA 1:20 But if una sin against mi, una go die.
ISA 1:21 Di town wey dey faithful before, don dey do like ashawo! Na only holy men dey inside before, but naw, na doz wey dey kill pipol, remain.
ISA 1:22 Jerusalem pipol, before-before, una bi like silva, but naw, una don dey yuzles. Una bi like good wine before, but naw, una bi like ordinary wota.
ISA 1:23 Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.
ISA 1:24 Naw, make una listin to wetin Israel God wey get pawa, dey tok, “I go fight against my enemies kon pay dem back for wetin dem do.
ISA 1:25 I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.
ISA 1:26 I go give una betta rulers with doz wey go advise una well just like di ones wey una get before. Den pipol go koll Jerusalem holy and faithful town.”
ISA 1:27 Bikos God dey holy, E go save Jerusalem and anybody wey turn from sin kom meet am.
ISA 1:28 But E go kill anybody wey dey sin and fight against am. E go kill anybody wey nor respet am.
ISA 1:29 Una go shame for unasef, bikos una woship trees kon build some juju gardin.
ISA 1:30 Una go fade like oak tree wey dey die; like gardin wey nobody pour wota put.
ISA 1:31 Just as dem dey distroy grass with fire, na so dem go distroy men wey get pawa bikos of di evil wey dem do and nobody go fit stop di distroshon.
ISA 2:1 Dis na di message about Judah and Jerusalem wey God give Isaya wey bi Amos pikin.
ISA 2:2 Time dey kom wen di mountin where di temple dey, go dey important pass evry oda mountin. Many nashons go-go der
ISA 2:3 and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.
ISA 2:4 E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.
ISA 2:5 So, Jakob shidren-shidren, make wi waka with di lite wey God take dey guide us!”
ISA 2:6 My God, Yu don forget yor pipol wey bi Jakob shidren-shidren, bikos dem dey do majik for evriwhere for di land; dem dey go meet majik pipol just as Filistia pipol dey do and na strenjas bi dia friends naw.
ISA 2:7 Na silva and gold full di land and Israel pipol propaty nor dey finish. Horse plenty for dia land and dia shariot, too many to kount.
ISA 2:8 Juju still full dia land too and dem dey woship tins wey dem use dia hand take make.
ISA 2:9 Pipol dey bow dey woship dem, so my God, make Yu nor forgive dem at-all!
ISA 2:10 Dem go hide inside rock and dig hole for groun make dem for fit eskape from God vexnashon and en glory.
ISA 2:11 Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.
ISA 2:12 True-true, God wey dey lead di sojas for heaven don plan di day wey E go judge evritin, bikos E go disgrace di pipol wey feel sey dem get pawa and dey make mout.
ISA 2:13 E go distroy all di tall cedar trees for Lebanon, with di oak trees for Bashan
ISA 2:14 kon level di high mountins and hills,
ISA 2:15 with evry high towa and strong wall.
ISA 2:16 Yes! E go sink and distroy big and fine-fine ship.
ISA 2:17 For dat day, God go distroy doz wey dey karry body up kon disgrace sturbon pipol and na only en name pipol go dey praiz.
ISA 2:18 E go distroy all di juju dem finish.
ISA 2:19 Wen God won kom shake dis eart with en pawa and glory, pipol go hide for hole, inside rock den dig hole for groun so dat dem go eskape from God vexnashon.
ISA 2:20 Wen dat day go rish, pipol go karry di gold and silva juju wey dem make for demsef kon trow and abandon dem give rats and bats.
ISA 2:21 True-true, wen God go kom shake di world, pipol go hide inside hole for rock, so dat dem go fit eskape from God vexnashon and en glory.
ISA 2:22 So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
ISA 3:1 Naw, di Oga God wey get pawa won remove evritin and anybody wey Jerusalem and Judah pipol dey depend on. E go still remove dia food, wota, guards,
ISA 3:2 strong men, sojas, judge, profets, doz wey dey si future, leaders,
ISA 3:3 sojas oga, dia pipol, advisers and doz wey sabi do majik.
ISA 3:4 God sey, “I go make yong pipol rule dem and na wiked yong men go bi dia oga.
ISA 3:5 Dem go dey fight each oda; Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour. Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey curse doz wey dem bin dey respet.”
ISA 3:6 Time dey kom wen pesin go hold en broda hand kon sey, “Since yu get yor own klot to wear, na yu bi awa leader. Den yu go fit kontrol all di wahala and trobol wey wi dey face.”
ISA 3:7 But e go ansa, “Nor bi mi, I nor fit help una. I nor get any food or klot for my house, so make una nor make mi una leader!”
ISA 3:8 Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall! Evritin wey dem dey tok and do, dey make God vex, bikos dem dey oppoz God law.
ISA 3:9 Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
ISA 3:10 So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.
ISA 3:11 But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.
ISA 3:12 Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money, don turn to dia oga. My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una nor know di rite road wey una suppose follow.
ISA 3:13 God don dey ready to judge. Yes! E don ready to judge en pipol.
ISA 3:14 God won judge doz wey dey lead en pipol. E sey, “Na una skata di vineyard kon pak poor pipol tins full una house.
ISA 3:15 Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money?
ISA 3:16 God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up! Dem dey waka dey karry dia head up and roll dia eyes. Dem dey waka small-small make dia shain for dey make nois.
ISA 3:17 But I go ponish dem, I go kut dia hair kon shave dia head to bololo.”
ISA 3:18 Di day dey kom wen God go kollect evritin wey dey make Jerusalem wimen dey make yanga; dat is, di ring wey dem dey wear for dia hand, head, neck
ISA 3:19 and dia waist. E go kollect dia klot,
ISA 3:20 dia priest kap, di majik wey dem wear for dia hands and waist;
ISA 3:21 di rings wey dem wear for dia fingers and nose;
ISA 3:22 all dia fine robes, gowns, koat, pus;
ISA 3:23 dia garments wey dey show dia body; dia handkachief, dia head-tie and di long klot wey dem dey wear for dia head.
ISA 3:24 Instead make dem dey scent well, dem go dey smell. Instead make dem wear betta belt, dem go tie rope for waist. Instead make dia hair fine, hair nor go dey dia head at-all. Na rag dem go dey wear, instead of fine klot. Dia beauti go turn to shame!
ISA 3:25 Di town men and doz wey strong well-well, dem go kill all of dem for war.
ISA 3:26 Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn, bikos of dia pipol wey die.
ISA 4:1 For di last days, seven wimen go hold one man kon sey, “Wi go feed and buy klot for awasef, but make yu just let us koll yu awa husband, so dat pipol nor go laf us, bikos wi nor get husband.”
ISA 4:2 For dat time, God go make evry plant and tree grow big and fine well-well again. All di pipol wey go survive for Israel, go like di tins wey di land go produce.
ISA 4:3 Den doz wey God save wey go remain for Jerusalem, pipol go koll dem, “holy pipol.”
ISA 4:4 God go use en pawa take judge and make di nashons holy. E go forgive Jerusalem pipol dia sins kon klean di land bikos of pipol wey dem kill for der.
ISA 4:5 Den God go kover and guide Mount Zion with all di pipol wey gada der with kloud for day time and fire for nite. Yes! God glory go kover and protet di whole town.
ISA 4:6 For day time, God glory go kover di town from strong heat kon protet am from heavy rain.
ISA 5:1 Naw, I go sing to my love; I go sing about en vineyard. My love vineyard dey on-top one hill wey get betta soil.
ISA 5:2 E build fence round di land kon remove di small-small stones wey nor go make di vine grow well, den e plant vine put. E build one towa for di middle kon dig pit where e go press di grape put. But as e dey wait, instead make di grape produce betta fruit, e kon produce bad ones.
ISA 5:3 So, my love sey, “Jerusalem and Judah pipol, make una judge between mi and my vineyard.
ISA 5:4 E get anytin wey I nor do for dis vineyard? So, wetin make am dey produce bad grapes, instead of good grape, just as I espect?
ISA 5:5 Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard: I go remove di fence wey dey round am kon break di wall wey dey protet am. I go let animals chop and mash am anyhow.
ISA 5:6 I go let grass grow for evriwhere and I nor go trim di vine or use hoe dig di groun again, instead, I go let dirty kover am and rain nor go ever fall put again.”
ISA 5:7 Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.
ISA 5:8 Una own don finish! Una wey dey buy all di house and field join di ones wey una get, so dat pipol nor go get where dem go stay again. Naw, na only una go dey di land.
ISA 5:9 God wey dey lead heaven sojas sey, “One day, all dis big fine house go skata and nobody go stay inside again.”
ISA 5:10 True-true, big vineyard go produce only five gallon of wine and ten basket of seed go produce only one basket of good korn.
ISA 5:11 Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink. Una dey drink still evening until di drink katch una well-well.
ISA 5:12 Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,
ISA 5:13 so dem go karry una komot una land bikos una nor undastand. Una leaders go hongry till dem die and una pipol nor go si wota drink.
ISA 5:14 Deat go open en mout wide dey wait dem and all di big and betta pipol with doz wey dey celebrate for Jerusalem, go soon enter deat mout.
ISA 5:15 Dem go disgrace evribody kon honbol pipol wey dey karry body up.
ISA 5:16 Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
ISA 5:17 Plenty sheep and oda animals go kom chop grass for di towns wey God don skata.
ISA 5:18 God go ponish pipol wey dey kause trobol with dia sins and lie-lie words; dem dey use dia hand bring wahala for demsef, bikos of dia wikedness.
ISA 5:19 Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do, so dat wi go si. Make Israel God wey dey Holy do wetin E plan, so dat wi go know.”
ISA 5:20 Una own don finish! Una wey dey sey bad tins, good and good tins, bad or sey darkness na lite and lite na darkness. Una dey sey bitter tins sweet and sweet tins bitter.
ISA 5:21 Pipol wey tink sey dem wise and get sense, bi like doz wey don die.
ISA 5:22 Una own don finish! Pipol wey bi champion for where dem for dey drink ogogoro! Dem dey get heart well-well wons e rish to mix difren drinks!
ISA 5:23 Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent, bikos dem don take bribe.
ISA 5:24 So, as straw and dry grass dey burn for fire, na so too dia life and all di betta tins wey dem get, go dry and blow trowey, bikos dem don rijet wetin Israel God wey get pawa, tish us.
ISA 5:25 God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
ISA 5:26 God dey use sign take koll pipol from far-far nashon. E dey blow trumpet take koll dem from evriwhere for di world and dem dey gada kom kwik-kwik.
ISA 5:27 No one taya or stagga for road and dem nor stop to rest or sleep for road. Dia belt nor kut and dia sandal rope nor ever luz.
ISA 5:28 Dem sharp dia arrow well and dia bows don ready to shot. Dia horse dey make nois like stone wey dem nak togeda and dia shariot taya dey turn like strong breeze.
ISA 5:29 Di sojas dey shaut like lion wey kill animal kon karry am go where nobody go for fit take am from am.
ISA 5:30 Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol; di nois go sound like wave for sea wey nak rock. Den wen yu look di land, yu go si sey e skata and dey dark, bikos di kloud don turn dia lite to darkness.
ISA 6:1 For di year wen King Uzzaya die, I kon si vishon as God sidan for en throne wey get glory for heaven and en klot kover di temple.
ISA 6:2 Di kind creatures wey stand near am, dey bring out fire from dia mout and each of dem get six-six feada. Dem kover dia face with two feada; use two kover dia leg, den dem dey use di oda two take dey fly.
ISA 6:3 Each of dem dey sing dey sey, “holy, holy, holy! Na God wey get pawa, dey holy and en glory full di world.”
ISA 6:4 Dia vois dey make di temple foundashon shake and smoke kon full di whole temple.
ISA 6:5 I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
ISA 6:6 Den one of di creature fly kom meet mi for groun and e use big sizos take hold shako wey dey burn and na from di altar e for karry am kom.
ISA 6:7 E use di hot shako take tosh my lips kon sey, “Dis tin don tosh yor lip, so from naw, yu don dey klean, bikos God don forgive yu.”
ISA 6:8 Den I hear God ask, “Who I go send? Who go bi awa messenja?” So, I kon ansa, “I go-go! Make Yu send mi!”
ISA 6:9 So E tell mi make I go give di pipol dis message: “E nor get as una go listin rish, una nor go undastand. E nor get as una go look rish, una nor go know wetin dey happen.”
ISA 6:10 Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”
ISA 6:11 I kon ask, “Oga God, how long dis tins go take happen?” E ansa, “Na till di town skata finish and nor-tin go dey inside again. Till nobody dey stay di house and na until di land don turn where dem dey trow dirty put.
ISA 6:12 I go send my pipol go far place and nobody go stay for di land again.
ISA 6:13 Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”
ISA 7:1 Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.
ISA 7:2 So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.
ISA 7:3 So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.
ISA 7:4 Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.
ISA 7:5 Siria with King Pekah and en pipol don plan against yu.
ISA 7:6 Dem sey, ‘Make wi go attack and distroy Judah town, den wi go make Tabeel pikin, dia king.’
ISA 7:7 But mi, God don tok sey, “E nor go work and e nor go happen,
ISA 7:8 bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.
ISA 7:9 Na Samaria bi Israel main town and na King Pekah dey rule am. So if yu nor gri bilive or trust and put yor hope for God hand, den yu nor go fit stand and yu go really die.”
ISA 7:10 God send anoda messenja go meet King Ahaz sey.
ISA 7:11 “Make yu ask God wey bi yor God make E show yu sign. Di one wey go make yu bilive sey God don tok. Yu fit even ask make E do mirakle for yu.”
ISA 7:12 Den King Ahaz ansa, “I nor go ask for sign and I nor go fit tempt my God.”
ISA 7:13 So Isaya sey, “Listin naw, una wey bi David shidren-shidren. Even doh e bad to dey try ordinary human being patient, una won try God own too?
ISA 7:14 So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
ISA 7:15 Na milk and honey e go dey chop and dis food go help am know how to rijet evil and choose wetin dey good.
ISA 7:16 Even before di pikin go know how to rijet evil and choose wetin dey good, doz two kings wey dey make una fear, God go don skata dem with dia pipol.
ISA 7:17 Time dey kom wen God go bring trobol kon give yu, yor pipol and all di royal family and e go bad pass anytin wey don happen since Israel kingdom separate from Judah and from Assyria king.
ISA 7:18 “Wen dat time rish, God go blow wiso as sign for Egypt pipol and dem go kom like fly from evriwhere for Nile. Assyria pipol go kom from dia land like bees kon attack una too.
ISA 7:19 Dem go dey waka for di valley and for di holes wey dey di rock. Yes, dem go kover evry shuku-shuku, bush and grass for di land.
ISA 7:20 Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.
ISA 7:21 Wen dat time rish, even if na only one melu and two goats di farmer fit save,
ISA 7:22 dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.
ISA 7:23 Wen dat time rish, di vineyard wey fine well-well and get one tazon vine wey rish one tazon pieces for silva, shuku-shuku go grow kover am.
ISA 7:24 Pipol go dey go use dia bow and arrows take katch animals for der. Yes, shuku-shuku go full evriwhere.
ISA 7:25 Na so too shuku-shuku go kover all di tins wey dem plant for di hill and nobody go fit go der again. E go bi where melu and sheep for dey go chop grass.”
ISA 8:1 God tell mi, “Make yu take one big board kon rite dis tins put, ‘Maher-Shalal-Hash-Baz.’ ” (Wey mean, “Kwik Karry Make Yu Distroy Fast-fast.”)
ISA 8:2 “Den take two men wey yu trust; Uriaya wey bi priest and Zekaraya wey bi Jeberekaya pikin, so dat dem go bi witness.”
ISA 8:3 So afta sometaim, my wife kon get belle. Wen e don born awa son, God kon tell mi, “Make yu koll am, ‘Kwik karry Make Yu Distroy Fast-fast.’
ISA 8:4 Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”
ISA 8:5 God tell mi again sey,
ISA 8:6 “Bikos dis pipol rijet Shiloah kwayet wota wey dey flow pass, but dey fear wons dem si Rezin and Pekah,
ISA 8:7 mi wey bi God go bring kings and dia sojas kon attack Judah. Dem go kom like Eufrates River wey dey flow well-well.
ISA 8:8 Dem go distroy Judah like wota wey distroy tins. Dem go spread dia feada kon kover di land and sey, ‘O Immanuel.’ ”
ISA 8:9 Dem go distroy di town kon skata evriwhere! So make una listin, all di far-far land for di eart. Make una dey ready to fight, but dem go still distroy una!
ISA 8:10 Even if una plan, una nor go susid. Make una tok anytin wey una wont, but all of dem go dey yuzles, bikos God dey with us.
ISA 8:11 True-true, dis na wetin God tok. E hold mi kon warn mi sey make I nor bihave like dis pipol:
ISA 8:12 “Make yu nor join di pipol plan and nor fear di tins wey dem dey fear.
ISA 8:13 Make yu remember sey, mi wey bi God wey get pawa, dey holy, so na mi yu must fear.
ISA 8:14 Bikos I dey holy; I bi like stone wey dey fall pipol and rock wey dey make pipol stagga. Yes! I bi like trap wey go katch pipol for Jerusalem.
ISA 8:15 Di stone and bricks go make many pipol stagga and fall and dem go wound well-well and di trap go katch dem.”
ISA 8:16 Una wey dey follow God, make una guide and keep di message wey E give mi.
ISA 8:17 I go really wait for God wey don rijet Jakob family; I go wait for am.
ISA 8:18 Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.
ISA 8:19 But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”
ISA 8:20 Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.
ISA 8:21 Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God.
ISA 8:22 Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.
ISA 9:1 True-true, even wen God dey judge, E still promise to diliver us and wi nor go sofa again. Before-before, dem disgrace Zebulun and Naftali pipol, but naw, God don bring honor kom di place where di sea pass; di side afta Jordan River go rish where Galilee pipol dey.
ISA 9:2 Pipol wey dey waka for darkness don si lite. Lite dey shine for doz wey dey stay for di land where strong darkness dey.
ISA 9:3 Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
ISA 9:4 All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.
ISA 9:5 True-true, dem go burn di boot wey di sojas take fight and dia klot wey blood stain.
ISA 9:6 Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
ISA 9:7 En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
ISA 9:8 God don sey, “I go judge Israel pipol wey bi Jakob shidren-shidren.”
ISA 9:9 Israel and Samaria pipol wey get pride and sturbones go know kon sey,
ISA 9:10 “Di bricks house don fall, but wi go build am with stone again. Dem don kut di sikamore tree, but wi go replace am with cedar wood wey fine well-well.”
ISA 9:11 So God kon make dia enemies attack dem. E make dia enemy vex attack dem.
ISA 9:12 Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
ISA 9:13 Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.
ISA 9:14 So, na one day God go take ponish Israel leaders and en pipol. E go kut dia head and tail komot.
ISA 9:15 Na di old pipol and rulers, bi di head, while di tail, na di profet wey dey lie waka.
ISA 9:16 Di leaders don konfuse dis pipol kon lead dem enter distroshon.
ISA 9:17 So God nor go let any of di yong men eskape; pity for doz wey dia husband don die or doz wey nor get papa and mama again. Bikos all of dem dey wiked; dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well. But God vexnashon nor go end and E still dey ready to ponish en pipol.
ISA 9:18 Di pipol wikedness dey burn like fire wey dey distroy both grass and shuku-shuku. E dey burn forest and en smoke dey go up to heaven.
ISA 9:19 Bikos God wey get pawa dey vex, en ponishment dey burn di land like fire and E dey distroy di pipol and dem nor dey sorry for each oda.
ISA 9:20 Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.
ISA 9:21 Manasseh pipol dey fight Efraim pipol, den dem join togeda go fight Judah pipol. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
ISA 10:1 Una own don finish! Una wey dey make wiked laws and dey opress my pipol.
ISA 10:2 Una dey opress poor pipol and nor gri give dem dia freedom. Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.
ISA 10:3 Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?
ISA 10:4 Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
ISA 10:5 God sey, “I dey use Assyria pipol as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.
ISA 10:6 I send Assyria pipol go attack di nashons wey nor know mi kon karry, tif and skata di pipol like dirty for street.
ISA 10:7 But Assyria king get en own wiked plan for mind, wey bi to distroy many nashons.
ISA 10:8 E even dey boast sey, ‘All my kommanders go bi king!
ISA 10:9 I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.
ISA 10:10 Even kingdoms wey dia juju strong and fine pass Jerusalem and Samaria own, I still distroy dem.
ISA 10:11 So just as I don do to Samaria and all en juju, na so too I go do to Jerusalem and all di juju wey dem dey woship.’ ”
ISA 10:12 But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”
ISA 10:13 Assyria king sey, “Na mi win all dis nashons by mysef. I strong well-well, wise and get sense. I skata nashons boundary kon karry all dia propaty. Na with my strong hand and pawa I take distroy strong rulers and kings.
ISA 10:14 All di nashons bi like bird house for my hand and I gada dia propaty just as dem dey gada egg. Yes! No feada fit make mi fear and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”
ISA 10:15 But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”
ISA 10:16 Bikos of dis, Oga God wey get pawa go ponish en pipol with sickness. Yes! En glory go-go up like smoke.
ISA 10:17 Den God, wey bi Israel lite, go bi like fire. God wey dey holy go bi fire and E go use one day take burn Assyria king and en pipol.
ISA 10:18 Just as pesin wey dey sick dey die dey go, na so too God go distroy Assyria forest and en beauti
ISA 10:19 and na only some tree wey shidren go fit kount, go remain.
ISA 10:20 But time dey kom wen Israel pipol wey go survive nor go depend on di pipol wey almost distroy dem. Instead dem go only depend and trust Israel God wey dey holy.
ISA 10:21 Some of dem go kom back! Yes Jakob shidren wey remain go kom back to dia God wey get pawa.
ISA 10:22 But as Israel pipol plenty like san-san for wotaside, na only few go kom back, bikos na di distroshon wey fit dem, dey wait for dem.
ISA 10:23 Yes! Oga God wey get pawa go bring distroshon kom di whole kountry, bikos E don tok am.
ISA 10:24 Oga God wey get pawa tell en pipol for Zion, “Make una nor fear Assyria pipol; even doh dem dey opress una as Egypt pipol bin do una.
ISA 10:25 E remain small for mi to ponish una finish, den I go distroy dem for una.
ISA 10:26 Mi, God wey get pawa, go use my kane take flog dem, just as I flog Midian pipol for Oreb Rock. I go ponish Assyria pipol, just as I take ponish Egypt pipol before.
ISA 10:27 Wen dat time rish, I go free una from Assyria pipol pawa and dem nor go bi load for una shoulder again. I go free una, bikos dia load go too dey heavy for una to karry.”
ISA 10:28 Enemies don katch Ai town! Dem leave dia tins for Mikmash kon pass thru Migron,
ISA 10:29 den dem cross kon go sleep for Gibeah dat nite! Pipol for Rama town dey fear and di pipol wey dey for Saul village for Gibeah, don run komot der.
ISA 10:30 Gallim pipol! Make una shaut well-well! Laishah pipol! Make una listin naw. Anatot pipol! Make una ansa!
ISA 10:31 Madmenah and Gebim pipol dey run go hide, so dat dem nor go die.
ISA 10:32 Enemies dey Nob town today and dem dey ready for war for Mount Zion wey dey Jerusalem.
ISA 10:33 But awa Oga God wey get pawa go kut and skata dem for groun like tree branches. Di ones wey dey proud and dey karry body up, God go ponish dem well-well.
ISA 10:34 God go kut dem with axe, just as dem dey kut big trees for forest and dem go fall for groun like Lebanon fine tree!
ISA 11:1 For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.
ISA 11:2 God Spirit go dey with am. E go gi-am di Spirit wey dey give wisdom; di Spirit wey dey give knowledge and di Spirit wey dey give good undastandin. E go still gi-am di Spirit wey dey give pawa and di Spirit wey go make am rule well. E go gi-am di Spirit wey go make am fear God and do wetin E wont.
ISA 11:3 E go always dey happy to obey God. E nor go judge pipol anyhow or with wetin dem tell am.
ISA 11:4 E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.
ISA 11:5 E go rule en pipol with betta mind and respet.
ISA 11:6 Just as wolf and sheep wey nor dey gri but kon stay togeda for peace, na so too leopard go liedan with yong goat. Yong sheep and small lion go chop togeda and small pikin go dey kare for dem.
ISA 11:7 Melu and bear go chop togeda and dia pikin go liedan togeda with happiness. Den lion go dey chop grass like melu.
ISA 11:8 Snake wey get poizin nor go bite small pikin, even if e near am or put hand for en mout.
ISA 11:9 So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.
ISA 11:10 Di day dey kom wen di new king from David family go bi sign to all di nashons. Pipol go gada for en royal town; gi-am respet kon ask make e guide dem.
ISA 11:11 Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
ISA 11:12 God go raiz flag as sign for di pipol; E go gada dem togeda again with all en pipol wey skata for evriwhere for di eart.
ISA 11:13 Efraim pipol nor go jealous Judah pipol and Judah pipol nor go hate Efraim pipol again.
ISA 11:14 Dem go attack Filistia pipol togeda for di west kon kill di pipol wey dey east. Dem go distroy Edom and Moab pipol and Ammon pipol go dey obey dem.
ISA 11:15 God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.
ISA 11:16 E go kreate one way wey en pipol wey remain go take komot for Assyria land, just as e happen for Israel pipol wen dem dey komot from Egypt.
ISA 12:1 For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.
ISA 12:2 Si! Na God dey save mi. I go trust am and I nor go fear. Na God dey give mi pawa and strent and na-im dey save mi.
ISA 12:3 As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy, na so too I go happy wen God save mi.”
ISA 12:4 For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish.
ISA 12:5 Make wi sing give God, bikos of di great tins wey E don do and make di whole world hear di news.
ISA 12:6 Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”
ISA 13:1 Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.
ISA 13:2 Make yu go on-top di hill go raiz di war flag! Make yu shaut and wave yor hand, so dat di sojas go fit enter di prince gate.
ISA 13:3 I don give orda to di sojas wey I choose, I go take revensh thru di sojas wey I give pawa to fight and dem go show as I dey vex rish.
ISA 13:4 Di mountin dey make nois like wen many sojas dey mash! Strong wahala dey among di kingdoms and nashons dey gada togeda! Oga God wey dey lead heaven sojas, dey gada dem togeda to go fight.
ISA 13:5 Dem kom from far-far kountry; from evriwhere for di world. Yes! God dey vex kom skata di whole kountry.
ISA 13:6 So make una kry with pain, bikos di day wen God go judge una don near; di day wen God wey get pawa won take distroy evritin.
ISA 13:7 So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.
ISA 13:8 Fear go katch all of dem with pain like woman wey won born. Dem go dey look each oda with fear and shame go full dia face.
ISA 13:9 Si, di day wey God go judge us dey kom; na dat day E won take show en vexnashon, den di eart go turn to desert and E go distroy evribody wey dey sin.
ISA 13:10 True-true, all di stars and oda tins wey dey shine, go stop to shine. Di sun go dark as soon as e won kom out and di moon nor go give any lite again.
ISA 13:11 God sey, “I go bring wahala kom di eart and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin. I go make anybody wey dey proud, honbol and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.
ISA 13:12 Just as pure gold nor plenty, na so too di pipol wey go survive, nor go plenty.
ISA 13:13 For di day wey mi, God wey get pawa go show my vexnashon, I go shake di heavens and di eart go shake komot from where e dey.
ISA 13:14 Di strenjas for Babilon go run go dia own land and dem go skata like animals wey dey eskape from hunta or like sheep wey nor get who dey look dem.
ISA 13:15 Anybody wey dem katch, dem go shuk am die and anybody wey dem seize, na swod go kill-am.
ISA 13:16 Dem go kill dia own shidren for dia front; dem go tif evritin for dia house and oda pipol go rape dia wifes for dia present.”
ISA 13:17 God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol. Dem nor dey kare about silva and nobody fit tempt dem with gold.
ISA 13:18 Dem go use dia bows and arrows kill di yong men and dem nor go pity for small shidren or new born baby.
ISA 13:19 Na Babilon pipol fine pass for all di kingdom and na dis make dem dey proud. But mi God, go distroy Babilon, just as I take distroy Sodom and Gomorrah!
ISA 13:20 Nobody go stay der again. No human being go ever stay der again and nobody wey get animals go karry en animal go chop grass for der again.
ISA 13:21 Na wild animals go dey stay der and na birds go full dia house wey go don skata. Ostrich go dey stay der and na for der wiked goats go for dey play.
ISA 13:22 Hyenas and jackals go dey make nois for di towa and di palis, bikos Babilon time don nearly finish! En days don dey pass!”
ISA 14:1 Oga God go pity en pipol, Israel. E go choose dem as en own kon let dem stay di land again and strenjas go kon stay der with dem.
ISA 14:2 Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land. Israel pipol go kom back to di land wey God give dem and pipol go serve dem. Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem kon rule di pipol wey bin sofa dem.
ISA 14:3 Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do,
ISA 14:4 dem go laf Babilon king kon sey, “Make una si as evritin take end for di king wey dey opress pipol! E nor go ever fit opress anybody again!
ISA 14:5 God don break wiked pipol pawa and di hand wey dem take dey rule.
ISA 14:6 Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
ISA 14:7 But naw, di whole eart dey rest; get peace and evribody dey sing with happiness.
ISA 14:8 Cypress trees and cedars for Lebanon dey happy bikos di king don fall, so nobody go kut dem trowey again.
ISA 14:9 Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king. Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life, dia ghost dey wait am and all di former kings ghost raiz from dia throne dey wait am too.
ISA 14:10 All of dem dey sey, ‘Naw, yu don dey weak like us! Yu don bi like us!
ISA 14:11 Before-before, dem dey play music with harp to give yu respet, but naw, yu dey with dead pipol. Yu liedan for worm bed kon use di worms take do kover klot.’ ”
ISA 14:12 Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine; make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall! Before-before, yu katch many pipol, but naw, dem don trow yu for groun.
ISA 14:13 Yu bin tell yorsef sey, “I go klimb go heaven go put my throne on-top di highest stars. I go sidan and rule like king for di highest mountin.
ISA 14:14 I go klimb go di place wey high pass for di kloud. I go bi like di Most High God!”
ISA 14:15 But God don bring yu down to di place wey deep pass and na der dead body dey stay.
ISA 14:16 Dead body dem go look yu kon ask demsef, “Nor bi dis man bin dey shake di eart kon make kingdoms dey fear?
ISA 14:17 Nor bi dis man distroy towns kon turn di world to desert? Yes! Na di man nor gri free en prisonas make dem go dia house!”
ISA 14:18 And all di kings for di world liedan for dia grave,
ISA 14:19 but yu nor get grave, just like bullet wey dem shot trowey. Yor dead body just dey groun with oda pipol wey dem kill with swod; with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.
ISA 14:20 Dem nor go beri yu like oda kings, bikos yu distroy yor own land kon kill yor pipol. Nobody from yor wiked family go survive.
ISA 14:21 Make dem bigin kill di king sons, bikos of dia grand-grand papa sin. No one among dem go rule for dis world or build towns again.
ISA 14:22 God wey get pawa sey, “I go attack and skata Babilon. I nor go leave anytin or pesin for der; nobody go survive at-all and pipol nor go remember am again.
ISA 14:23 I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay and wota wey nor dey go front or back, go full di land. I go swip am trowey, just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”
ISA 14:24 God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.
ISA 14:25 I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.
ISA 14:26 Dis na wetin I plan for di whole eart; my hand dey ready to ponish di nashons.”
ISA 14:27 True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan and who go fit stop wetin E won do? En hand dey ready to ponish anybody. So who go fit stop am?
ISA 14:28 Na for di year wey King Ahaz die, God take send dis message:
ISA 14:29 Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
ISA 14:30 Na God dey guide and save poor pipol. But E go make honga kill Filistia pipol finish.
ISA 14:31 Filistia towns! Make una shaut and kry for help. Make una fear, bikos betta smoke dey kom meet una from nort and dem bi strong sojas wey nor dey fear.
ISA 14:32 How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.
ISA 15:1 Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.
ISA 15:2 Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.
ISA 15:3 Na sak evribody go wear dey waka; dem go dey mourn and kry for dia house and for evriwhere for di town.
ISA 15:4 Heshbon and Elealeh pipol go kry and Jahaz pipol wey dey far go hear dem. Bikos of dis, Moab sojas dey shaut with pain and dem nor get heart again.
ISA 15:5 My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.
ISA 15:6 Naw, Nimrim river don dry; all di grass wey near am don dry too and no green grass remain for der again.
ISA 15:7 Bikos of dis, di pipol karry evritin wey dem don make and keep kon go Willows Valley.
ISA 15:8 True-true, pipol dey hear as Moab pipol dey kry for evriwhere and dia kry dey rish Eglaim and Beer-Elim town.
ISA 15:9 Na blood full Demon river! God sey, “I go kause more trobol for Dimon town. One lion go kom attack and kill Moab pipol wey dey won eskape and di remainin pipol wey dey di land.”
ISA 16:1 So make yu send lamb as gift from Sela town wey dey di desert, go give Jerusalem rulers.
ISA 16:2 Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.
ISA 16:3 Dem sey, “Make una help and defend us from awa enemies. Make una protet us bikos dem dey always attack us. Make una nor leave us naw wey wi don run komot from dia hand.
ISA 16:4 Abeg! Make una allow us stay with una, so dat una go protet us from awa enemies! Wen doz wey opress us don die and distroshon nor dey again and awa enemies don disappear,
ISA 16:5 den one among David shidren-shidren go bi king and e go rule di pipol with en whole heart and love. E go dey do wetin dey rite and e go make sure sey dem nor opress anybody again.”
ISA 16:6 Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”
ISA 16:7 So Moab pipol go kry bikos of di wahala wey dem dey face; all of dem go kry if dem remember di fine food wey dem bin dey chop for Kir-Hareset town,
ISA 16:8 bikos dem don distroy di farm wey dey near Heshbon kon skata di vineyard for Sibmah. Yes! Di rulers for di nashons skata di vines go rish Jazer kon enter di desert, den cross di sea.
ISA 16:9 So, I kry for Sibmah vine, just as I kry for Jazer. I dey kry for Heshbon and Elealeh pipol, bikos dem distroy all di food wey dem plant.
ISA 16:10 Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
ISA 16:11 My heart dey kry for Moab and Kir-Hareset pipol.
ISA 16:12 Moab pipol prayer nor go mean anytin, even wen dem klimb di hill go dia juju temple go pray and kry!
ISA 16:13 Dis na di message wey God bin tok about Moab pipol.
ISA 16:14 But naw, God sey, “For di next three years, Moab pipol and dia propaty go vanish komot dis eart and na few pipol go survive among all di pipol and dem go dey weak well-well.”
ISA 17:1 Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.
ISA 17:2 Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.
ISA 17:3 Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol.
ISA 17:4 God sey, “For dat time, Israel pipol pawa go finish and na sofa go bi dia own.
ISA 17:5 E go bi like wen pesin gada rice kon blow di kanda trowey. Just like wen pesin dey blow kanda komot from rice for Refah Valley.
ISA 17:6 Na only few pipol go survive for Israel and e go bi like olive tree wey dem plok all en fruit komot kon leave like two or three fruit for en branches.
ISA 17:7 Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem; dem go depend on Israel God wey bi di King of all kings.
ISA 17:8 Dem nor go put dia hope for di altar wey dem make with dia hand or trust Asherah juju or di incense altar wey dem still make with dia hand.
ISA 17:9 For dat time, dia strong town go skata and dem go run komot der like di town wey Hiv and Ammon pipol abandon bikos of Israel pipol.
ISA 17:10 Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.
ISA 17:11 True-true, di day una start to plant, una dey do evritin wey una fit do, so dat di plant go grow. Di morning wey una start to klean di land, una dey do evritin wey una fit do to make di plant survive, but una nor go si anytin harvest and na only diziz and pain go follow una.
ISA 17:12 So all di strong nashons wey gada togeda nor betta pass pipol wey don die; dem just dey make nois like wave for sea.
ISA 17:13 Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.
ISA 17:14 For evening, dem go dey fear kon vanish before day break. Dis na wetin go happen to pipol wey dey trobol and won tif from awa land.
ISA 18:1 E go bad well-well for Ethiopia, di land where bird feada for dey make nois for river,
ISA 18:2 where messenjas dey travel pass with boat wey dem take soft wood make. Di messenjas go meet pipol wey tall and get smooth skin; pipol wey dem dey fear for evriwhere; wey dia nashon dey strong and always dey win war and wey river divide dia land.
ISA 18:3 Make evribody wey dey for di world, listin! Una go si one flag on-top di mountin, den una go hear one trumpet sound,
ISA 18:4 bikos dis na wetin God tell mi, “Just as dew dey form for nite wen harvest time rish and as sun dey shine for day time kon make evriwhere hot, na so too I go kwayet dey look una from heaven where I dey stay.
ISA 18:5 And before dem go gada di grapes wey don ripe afta di new leaf don fall, I go use my knife take kut di branches wey nor dey produce fruit kon break all di bad branches.
ISA 18:6 Dem go leave all di dead body for groun, so dat birds and wild animals go chop dem. Birds go chop dem for dry sizin and wild animals go chop dem for rainin sizin.”
ISA 18:7 For dat time, di pipol wey tall and get smooth skin, wey pipol dey fear for evriwhere; wey dia nashon dey strong and always dey win war and wey river divide dia land, go kom pay respet to God wey dey lead heaven sojas. Dem go kom honor God wey dey lead heaven sojas for di place wey E choose to stay for Mount Zion.
ISA 19:1 Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.
ISA 19:2 God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time, broda go fight against broda and neighbour go fight against neighbour. Town go fight against town and kingdom go fight against kingdom.
ISA 19:3 I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.
ISA 19:4 I go give Egypt pipol to one bad ruler and na wiked kings go rule dem.
ISA 19:5 River Nile go dry and all di oda river for Egypt go dry finish.
ISA 19:6 Di place where di river dey flow from go dey smell and all di rivers go dry.
ISA 19:7 All di plants wey dey float on-top di river, go dry; evritin wey dem plant near River Nile go die and breeze go blow dem trowey.
ISA 19:8 Fishermen go kry well-well. Yes! Pipol wey dey katch fish der and doz wey dey trow net for di river, go dey kry with pain.
ISA 19:9 Pipol wey dey make linen klot, go konfuse well-well and dem nor go know wetin to do.
ISA 19:10 Pipol wey dey weave and doz wey dem hire to work, go taya and weak well-well.
ISA 19:11 Zoan leaders na fools! Wise men for Egypt dey give di king yeye advise, if not, wetin go make yu tell Fero sey, “I dey among doz wey sabi rite and wi dey plan to ova-trow yu?”
ISA 19:12 And naw, where doz wise men wey dey advise di king? Make dem kon tok evritin wey God dey plan to do for Egypt na!
ISA 19:13 Zoan and Memfis leaders na fools. Na dem suppose lead di nashon, but bikos dem nor know di rite way, dem dey lead di pipol anyhow.
ISA 19:14 God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do, nor dey rite at-all and naw, di pipol dey stagga like drunkard man wey sleep on-top en vomit.
ISA 19:15 So, work or any betta tin nor go dey Egypt again; weda na for di leader or di ordinary pipol or di rish and di poor.
ISA 19:16 For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.
ISA 19:17 Den Judah pipol go sofa Egypt pipol and anybody wey go hear Judah pipol story, go dey fear, bikos of wetin God wey dey lead heaven sojas won do dem.
ISA 19:18 For dat time, five towns for Egypt go dey speak Kanaan language kon promise to serve God. Dem go koll one of di town, “Sun town.”
ISA 19:19 For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary.
ISA 19:20 E go dey remind pipol for Egypt about God. Wen dem dey opress di pipol and dem koll God make E kom help dem, E go send pesin go diliver and help dem.
ISA 19:21 God go show ensef to Egypt pipol; dem go woship am with ofrin and sakrifice kon know am well-well. Dem go promise God and do wetin dem promise.
ISA 19:22 Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.
ISA 19:23 Wen dat time rish, betta road go dey between Assyria and Egypt. Pipol for di two kountry go dey travel go visit each oda and di two nashon go woship togeda.
ISA 19:24 Wen dat time rish, Israel pipol go bi di same with Egypt and Assyria pipol and dis three nashon go bi blessing to di whole world.
ISA 19:25 God wey get pawa go bless dem kon sey, “Egypt wey bi my pipol, I go bless una. Assyria pipol wey I kreate and Israel pipol wey I don choose, I go bless una well-well too.”
ISA 20:1 God give dis message for di year wen King Sargon for Assyria send en kommander go fight and konker Ashdod.
ISA 20:2 For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.
ISA 20:3 Afta dem seize Ashdod town, God sey, “Isaya wey bi my savant naked dey waka about for three years naw. Dis na sign about wetin go happen for Egypt and Ethiopia.
ISA 20:4 Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.
ISA 20:5 Pipol wey trust Ethiopia and bilive sey Egypt go save dem, go fear and shame go katch dem.
ISA 20:6 For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”
ISA 21:1 Dis message na about Babilon. Just as strong breeze dey blow kom from desert, Na so wahala go kom from one land wey pipol dey fear.
ISA 21:2 I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”
ISA 21:3 So bikos of all dis tins wey I hear, my belle kon dey pain mi and e dey make mi fear. E dey pain mi like woman wey won born.
ISA 21:4 My heart dey shake and I dey fear well-well. Before, I dey like wen evening rish, but naw, I dey fear darkness.
ISA 21:5 Dem don arrange di party tabol; put rug for groun where pipol wey dem invite go sidan put. But as dem dey chop and drink, dem kon hear di kommand, “Una wey bi sojas, make una prepare for war!”
ISA 21:6 Den God tell mi, “Make yu go put pipol make dem dey guide, so dat dem go tell yu evritin wey dem si.
ISA 21:7 Dem must shine dia eye to si wen men wey dey ride horse dey kom two-by-two and doz wey dey on-top donkeys and kamels.”
ISA 21:8 Make di guide shaut, “Oga, I dey guide both for day and nite and na where yu sey make I dey, na der I dey”
ISA 21:9 Si, men wey dey ride horse dey kom. Den di guide sey, “Babilon don fall! All di juju wey dem dey woship, skata for groun!”
ISA 21:10 So my pipol Israel, wey dem mash for groun like flower, na di good news wey I hear from God wey dey lead heaven sojas, I don tell una so.
ISA 21:11 Dis message na about Edom pipol. Somebody koll mi from Edom land sey, “Yu wey dey guide, na wen day go break? Na wetin remain for di nite? Make yu tell mi wen all dis tins go end.”
ISA 21:12 So I ansa, “Morning dey kom, but nite go kom again. So if yu won ask again, wen dat time rish, make yu kom back kon ask.”
ISA 21:13 Dis message na about Arabia pipol. Dedan pipol wey dey stay for karavan for di empty kountry for Arabia.
ISA 21:14 Pipol wey wota dey hongry, make una give dem wota drink. Una wey bi Tema pipol, make una give doz strenjas food chop.
ISA 21:15 Bikos dem dey run from swod, bow and all di bad weapons wey dem take dey fight war, bikos dem nor won die.
ISA 21:16 And dis na wetin God wey get pawa dey tok, “Just one year from naw, all di pawa wey Kedar pipol tink sey dem get, go end.
ISA 21:17 Kedar pipol wey dey fight with bow and arrow, na dem strong pass, but na only few of dem go remain. Mi wey bi Oga God for Israel don tok and na so e must mi.”
ISA 22:1 Dis message na about di Vishon Valley: Wetin dey happen? Wetin make evribody dey klimb go on-top roof?
ISA 22:2 Di whole town dey make nois anyhow. Una pipol wey die, nor die for war, but na honga kill dem.
ISA 22:3 Una leaders run, but dem katch dem without any fight or sey dem shot arrow. Even wen di pipol try to run, dem still katch dem too.
ISA 22:4 So I kon sey, “Make nobody hold mi; make una allow mi kry well-well. Make I kry for my pipol, bikos dem don distroy dem and nobody dey to help dem.”
ISA 22:5 But awa Oga God wey dey lead heaven sojas get di day wen E go kause wahala and konfushon for Vishon Valley and evribody go beg make di mountins kom help dem.
ISA 22:6 Sojas ride horse from Elam land kom and dem karry bows and arrows. Sojas from Kir don dey ready to fight too.
ISA 22:7 Na shariot full Judah valley wey good well-well. Strong Sojas stand for Jerusalem gate.
ISA 22:8 Nobody dey defend Judah town again; all di pipol wey dey der don fall and dia sojas don run go bring dia swod from where dem hide dem put.
ISA 22:9 Una si all di wall wey dem break for David Town. Una store wota for di pool wey dey bottom.
ISA 22:10 Una kount di house for Jerusalem kon skata some house, so dat una go fit si tins wey una go take ribuild di walls.
ISA 22:11 Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.
ISA 22:12 For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.
ISA 22:13 But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”
ISA 22:14 But dis na wetin Oga God wey dey lead heaven sojas tell mi, “True-true, as long as dem dey alive, I nor go forgive dem dia sin.”
ISA 22:15 God wey get pawa wey dey lead heaven sojas, dis na wetin E tok, “Go meet Shebna wey dey manage di royal house kon tell am,
ISA 22:16 ‘Who give yu di rite to stay here? Wish of yor family memba dem beri for here? Who give yu rite to won dig grave for yorsef for here? Yu dey karve grave for yorsef inside di rock.
ISA 22:17 Yu dey feel sey yu dey important, but God go pick yu trowey for bush.
ISA 22:18 E go pick yu like ball kon trow yu go anoda land wey far well-well. Yu go die for der near di shariot wey dey make yu karry body anyhow. Yu bi disgrace for yor oga house.
ISA 22:19 God go remove yu from yor pozishon. E go trow yu komot from yor ofis.’ ”
ISA 22:20 God kon tell Shebna, “For dat time, I go koll my savant, Eliakim wey bi Hilkaya pikin
ISA 22:21 kon gi-am yor robe, di belt and all di pawa wey yu get. E go bi papa wey go dey protet Jerusalem and Judah pipol.
ISA 22:22 I go put David house key for en hand. Wen e open any door, nobody go fit lock am and wen e lock any door, nobody go fit open am.
ISA 22:23 I go nail am like peg for one strong place and e go bring honor and respet kom en papa family.
ISA 22:24 En whole family go dey popula bikos of am, dat is evribody wey rilate to am, go dey popula. Bikos of am, en family go balance like plate and pot wey dem hang for wall.
ISA 22:25 “For dat time, di peg wey bin dey der before, go fall for groun, den evritin wey hang on am, go skata.”
ISA 23:1 Dis message na about Tyre pipol. Una wey dey drive ship, make una kry with pain. Dem don skata una house and dem tell una di news as una ship dey kom from Cyprus.
ISA 23:2 Make una kry! Una wey dey stay near river and una wey bi tradas for Sidon, men wey dey travel round sea,
ISA 23:3 go sell food wey dem harvest for Egypt and dey do business with pipol for oda kountry.
ISA 23:4 Sidon pipol, make shame katch una, bikos sea and ocean don rijet una kon dey sey, “Wi neva feel pain like woman wey won born or sey wi don born pikin before; wi neva even train shidren before.”
ISA 23:5 Even Egypt pipol go sopraiz well-well wen dem hear evritin wey happen for Tyre.
ISA 23:6 So, Foenicia pipol wey dey stay near di sea, make una kry well-well! Make una run go Tarshish!
ISA 23:7 Una sure sey dis na Tyre, di town where dem for dey celebrate since? Town wey God kreate, wey en pipol dey difren place for di world?
ISA 23:8 Who bring all dis wahala kom Tyre wey en pipol na prince and wey pipol dey respet dia tradas well-well for di world?
ISA 23:9 Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.
ISA 23:10 Una wey dey Tarshish, make una travel go back to una land, just as pesin dey cross River Nile, bikos Tyre don skata.
ISA 23:11 God stresh en hand go di sea kon konker kingdoms, den kommand make dem distroy all di strong town for Kanaan.
ISA 23:12 God sey, “Sidon town, una joy don end and dem go opress una. Even if una run go Cyprus, una nor go dey save for der.”
ISA 23:13 Make una si Kaldean town, pipol wey nor know where dem from kom! Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay. Dem don skata dia towas, distroy dia strong town kon turn am to where dem dey trow dirty put.
ISA 23:14 So, una wey dey drive big ship, make una kry well-well, bikos dem don distroy di town where una for bin dey save.
ISA 23:15 For dat time, dem go forget Tyre for seventy years, wey bi di normal years wey king suppose stay for dis world. Wen dat time don pass, pipol go know Tyre again and e go bi like di ashawo wey dey dis song:
ISA 23:16 “Make una take di harp kon go round di town, una wey bi ashawo wey dem don forget! Make una play and sing una song, so dat men go kom meet una again.”
ISA 23:17 Wen di seventy years don pass, God go make Tyre strong again. Di town go kon rish and go dey sell tins give all di oda kingdoms.
ISA 23:18 Di profit wey dem go make, dem go gi-am to God. Dem nor go keep di money or allow am many for one place, but dem go give di profit to pipol wey always dey stay God present and dis pipol go use am take buy enough food and fine-fine klot wey dem go wear.
ISA 24:1 Si, awa Oga God dey ready to skata di world kon turn am to where dem dey trow dirty put. E go shake di world kon skata evribody wey dey stay inside.
ISA 24:2 Evribody go sofa; priests and pipol; slaves and dia oga dem; pipol wey dey buy and sell; pipol wey dey borrow odas money and doz wey dey borrow from dem; plus rish and poor pipol: all of dem go sofa di same tin.
ISA 24:3 Di world go skata finish and nor-tin go remain. God don tok and na so e go bi.
ISA 24:4 Di eart don dry, di whole world dey shake like pesin wey kold dey katch and e don dry too; pipol wey dey popula for dis world, don die go.
ISA 24:5 Di pipol wey dey dis world, don skata am with sin, bikos dem nor gri obey God law or keep en kovenant wey go last forever.
ISA 24:6 So, God don curse di world. Pipol dey pay for wetin dem do and dis na why dem dey die anyhow and na only few of dem remain for di world.
ISA 24:7 Di new grape vine don dry and wine nor dey again. All di pipol wey dey happy before, don dey vex naw
ISA 24:8 and dem nor dey play dia drums, harps or sing and happy again.
ISA 24:9 Dem nor dey sing or drink wine again, bikos nobody dey enjoy di taste bikos e dey bitter naw.
ISA 24:10 Di whole town don skata and pipol lock diasef inside dia house, so dat dem go dey save.
ISA 24:11 Dem dey shaut for dia street, bikos of wetin happen to dia wine. Happiness don komot di land forever and na sorrow full der naw.
ISA 24:12 Di town don skata and en gate don fall for groun.
ISA 24:13 Dis na wetin go happen for evriwhere for di world. E go bi like wen dem dey plok olive tree fruit for harvest time kon leave only di small-small wons for der.
ISA 24:14 Di pipol wey go survive go sing with happiness; doz wey dey for west go tok how God big and great rish
ISA 24:15 and doz wey dey for east, go praiz am. Di pipol wey dey stay near sea go praiz di Oga wey bi Israel pipol God.
ISA 24:16 Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!
ISA 24:17 So make evribody listin to mi! Wahala, big pit and trap wey dem set dey wait to katch and kill all di pipol for dis eart.
ISA 24:18 Anybody wey run from di wahala go fall for di pit and anybody wey won eskape from di pit, di trap go katch am, bikos wahala like heavy rain go fall from heaven and di eart foundashon go shake.
ISA 24:19 Di world don break to pieces; e don krack open kon dey shake well-well.
ISA 24:20 Di world go stagga like drunkard man; e go shake like house wey heavy rain dey disturb. En sin go draw am fall for groun; e go fall and e nor go raiz-up again.
ISA 24:21 For dat time, God go ponish di wiked spirits wey dey di sky with doz wey dey rule as kings for dis world.
ISA 24:22 God go gada dem put for pit, lock dem for prison and afta dem don stay der tey, E go kon ponish dem.
ISA 24:23 Di moon go dey dark and sun nor go shine again, bikos Oga God wey dey lead heaven sojas, go rule from Mount Zion for Jerusalem and evribody go si en glory wey big well-well.
ISA 25:1 Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.
ISA 25:2 Yu don turn di towns to where dem dey trow dirty put. Di place where strenjas for dey save before, nor bi town again and nobody go ribuild am.
ISA 25:3 Pipol from strong kountry go praiz Yu and wiked pipol from oda towns, go fear Yu well-well,
ISA 25:4 bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.
ISA 25:5 Just as heat dey make land dry, na so too Yu dey kwayet strenjas wey dey karry body up. Just as kloud shadow dey make hot place kool, na so too Yu dey silent wiked pipol.
ISA 25:6 For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.
ISA 25:7 Na for dis mountin God go for swallow sorrow, pain and evry bad tin wey dey trobol en pipol.
ISA 25:8 God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world.
ISA 25:9 Wen all dis tins dey happen, pipol go sey, “Look! Make una si God for here! Wi wait for am and E don kom diliver us. Si God for here! Wi really wait for am. So make wi rijoice and dey happy bikos E don save us.”
ISA 25:10 God go protet and guide Mount Zion, just as pipol dey mash grass pass, na so too E go take distroy Moab pipol.
ISA 25:11 Even wen dem stresh dia hand like man wey won swim, God go ponish dem and dia hands go weak, bikos of dia pride.
ISA 25:12 God go distroy di high wall wey Moab pipol take dey protet diasef and E go bring dem down forever.
ISA 26:1 For day time, pipol go sing dis song for Judah land: “Awa town dey strong well-well! God ensef dey defend awa wall and na-im dey make us strong!
ISA 26:2 Make una open di town gates, so dat di nashon wey dey faithful; wey en pipol dey do wetin dey rite, go fit enter.
ISA 26:3 Oga God, Yu dey guide and save pipol wey dey faithful, bikos dem trust Yu.
ISA 26:4 Make wi always dey trust God and E go protet us forever.
ISA 26:5 True-true, pipol wey dey karry body up, God dey bring dem down. E dey distroy and skata towns wey tink sey dem too strong. Yes, E dey trow dem for dust.
ISA 26:6 Pipol wey dem dey opress before, dey mash dem pass naw. Yes, poor pipol dey waka on-top dem naw.
ISA 26:7 Raitious pipol dey live korrect and good life and dia ways dey-dey strait.
ISA 26:8 My Oga God! Wi dey wait for Yu as Yu dey judge us. Yes! Na yor greatness and as Yu dey do yor tins, dey make us grow.
ISA 26:9 I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.
ISA 26:10 Even if Yu sorry for wiked pipol, dem nor go still learn how to do wetin dey rite and even for where raitious pipol dey rule, wiked pipol still dey do wiked tins; dem nor dey si God glory wey dey kom.
ISA 26:11 My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
ISA 26:12 My God! Na Yu make us dey save and dey prosper and even evritin wey wi get, na Yu give us.
ISA 26:13 Oga God, difren-difren pipol don rule us, but na only Yu wi go dey praiz forever.
ISA 26:14 Dis pipol don die and dem nor go kom back again. Dia spirit nor go fit raiz-up again, bikos Yu don judge and distroy dem.
ISA 26:15 Yu don make awa nashon big well-well and Yu kon show how Yu strong rish. Yes! Yu don make awa land wide well-well.
ISA 26:16 God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.
ISA 26:17 Just as woman wey get belle dey kry and shaut with pain wen e won born, na so too wi dey kry from awa heart for Yu wey bi awa Oga God.
ISA 26:18 Instead make wi born pikin, na breeze awa pain born. Wi neva win anytin and wi nor get shidren wey go take-ova awa world.
ISA 26:19 God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”
ISA 26:20 My pipol! Make una dey go! Make una enter una house kon lock una door! Make una hide unasef until God don vex finish,
ISA 26:21 bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.
ISA 27:1 For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.
ISA 27:2 Wen di time rish, make una sing about God vineyard!
ISA 27:3 “Na mi wey bi God go protet am, I dey always look and wota am. I dey guide am both for day and nite, so dat nobody go skata am.
ISA 27:4 I nor dey vex for di vineyard again. If enemies won attack my pipol, I go mash go fight and burn dem with fire.
ISA 27:5 But if my pipol enemies wont make I protet dem, make dem make peace with mi. Yes! Make dem make peace with mi.”
ISA 27:6 Time dey kom wen Jakob shidren-shidren go get rut like tree and dem go grow well. Di fruit wey dem go bear, go full di eart.
ISA 27:7 God don distroy Israel pipol, just as E do doz wey dey opress dem? E don kill Israel pipol as E kill dia enemies?
ISA 27:8 No, but God vex for en pipol kon send dem go Babilon as dia ponishment. E karry dem komot from dia land with one strong breeze from di east.
ISA 27:9 So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.
ISA 27:10 Naw, dem don distroy all di strong towns. E empty and e don turn desert where animals for dey kom look for food chop.
ISA 27:11 Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
ISA 27:12 Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one.
ISA 27:13 Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.
ISA 28:1 Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.
ISA 28:2 Si! God dey send one strong pesin wey get pawa well-well kom attack una. Di pesin go kom like heavy rain kon attack and distroy una with una land.
ISA 28:3 Di leaders wey drink dey katch, dem go mash dia crown for groun.
ISA 28:4 Di proud leaders glory wey don dey fade, go disappear like di first fig wey kom out for en sizin; pipol go plok dem chop wen dem neva ripe.
ISA 28:5 For dat time, God wey get pawa go bi betta crown wey get glory to en pipol wey survive.
ISA 28:6 E go give wisdom to doz wey dey judge, so dat dem go judge well. E go give strong heart to doz wey dey defend di town, so dat dem nor go fear any attack.
ISA 28:7 Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.
ISA 28:8 Dem don kover dia tabol with vomit and evriwhere dey smell.
ISA 28:9 Dem dey sey, “Who God dey try to tish sef? Who E dey esplain en message for? En message good for only shidren wey just stop to suck breast!
ISA 28:10 Bikos E dey won tish us word for word, line by line and lesin by lesin, do am like dis or do am like dat.”
ISA 28:11 So if una nor won listin, God go use strenjas wey go opress and tish una lesin with language wey una nor undastand.
ISA 28:12 Before-before, God tell dem, “Dis na where una go dey sikure, so doz wey don taya go fit rest for here. Yes! Dis na where una go fit rest put.” But dem nor gri listin to am.
ISA 28:13 So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.
ISA 28:14 So, all di sturbon and wiked rulers for Jerusalem, make una listin to wetin God dey tok.
ISA 28:15 Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.
ISA 28:16 Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’
ISA 28:17 Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.
ISA 28:18 Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.
ISA 28:19 Wen God dey Judge una, E go karry una go. E go judge di town both for day and nite. Na fear and pain dis message go give una wen una don undastand am.
ISA 28:20 Bikos di bed go too short to stresh body and di klot go too small to kover body.
ISA 28:21 Den God go raiz-up as E do for Mount Perazim and for Gibeon Valley, so dat E go do wetin E won do. Even if wetin E dey do dey sopraiz us; E go komplete en wonderful work.
ISA 28:22 So make una nor laf as I dey warn una, if not, e go hard una well-well to eskape. Bikos I hear wen God wey get pawa sey E go distroy di whole kountry.
ISA 28:23 Make una listin to wetin I dey tok; make una hear wetin I dey tish una.
ISA 28:24 E get farmer wey go just dey klear en land wen e suppose to dey plant?
ISA 28:25 Wons e just prepare di soil, e go plant di seed and herb put kon plant wheat, barley and rice for di korna.
ISA 28:26 E know how to do en work, bikos God don tish am how to work as farmer.
ISA 28:27 E nor dey use heavy hoe take dig di seed kom out, instead, e dey use small-small stik wey bi dia size.
ISA 28:28 E must grind en flour if e won make bread. En melu wey e take dey work, e know how e go take karry dem pass di farm, so dat dia leg nor go distroy di rice.
ISA 28:29 All dis wisdom dey kom from God wey dey lead heaven sojas. Na-im dey give pipol wisdom and dey guide us for evritin wey wi dey do.
ISA 29:1 Jerusalem, David town, una own don finish! Make una kontinue to dey do una sakrifice evry year, just as e suppose bi.
ISA 29:2 But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.
ISA 29:3 I go bi una enemy and I go attack, seize and distroy di town.
ISA 29:4 Jerusalem go fall and as dem dey groun dem go kry for help, but nobody go hear dia vois.
ISA 29:5 Jerusalem, all di strenjas wey attack yu and di sojas wey make yu dey fear, na wons God go blow dem komot like ordinary dust.
ISA 29:6 Den God wey dey lead heaven sojas go send en judgement kom with tonda, eartkweke and one loud vois. E go send strong rain and betta fire follow dem too.
ISA 29:7 E go bi like dream; like vishon for nite. Wahala go dey for all di pipol wey dey fight and disturb God town.
ISA 29:8 E go bi like man wey dey hongry, wey dream sey e dey chop, but wen e wake-up, e si sey en belle still empty. E go bi like man wey dey hongry for wota kon dey dream sey e dey drink, but wen e wake-up, e si sey wota still dey hongry am well-well. Na so e go bi for all di pipol wey dey fight and disturb Mount Zion.
ISA 29:9 Make una kontinue to dey fool unasef! Make una dey bihave like pesin wey nor dey si! Make una dey stagga fall even wen una nor drink wine. Yes! Make una dey stagga waka, even doh una nor drink!
ISA 29:10 God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.
ISA 29:11 To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”
ISA 29:12 Or if una gi-am to pesin wey nor sabi read make e read am, e nor go fit, bikos e nor sabi read.
ISA 29:13 God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
ISA 29:14 So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”
ISA 29:15 Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
ISA 29:16 Dem dey turn evritin up-side-down. Wish one dey important pass: di pesin wey dey mold di klay or di klay? Wetin pesin make fit ask am, “Na yu make mi?” Abi di pot fit tell who dey make am sey, “Yu know wetin yu dey do so?”
ISA 29:17 So e nor go tey again before Lebanon forest go turn betta groun and di betta groun so for Lebanon, go produce good good food.
ISA 29:18 Wen dat day rish, deaf pipol go hear words wey dem read from book give dem and blind pipol go si even inside darkness.
ISA 29:19 Poor pipol and doz wey honbol diasef go si di happiness wey di Oga wey bi Israel pipol God, dey give.
ISA 29:20 Bikos pipol wey dey opress odas go vanish and all doz wey like to dey do bad tins, go die.
ISA 29:21 God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours; pipol wey dey katch and kill pipol and doz wey nor dey give korrect judgement.
ISA 29:22 So Oga God wey diliver Abraham, dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren: “My pipol, dem nor go disgrace una again and una nor go dey shame again.
ISA 29:23 Wen una go si di shidren wey I go give una, den una go know sey na mi bi Israel God wey dey holy and una go honor my name. Una go honor mi wey bi una King. Yes! Una go respet Israel pipol God.
ISA 29:24 Doz wey dey foolish go undastand well and pipol wey dey always komplain, go get wisdom.”
ISA 30:1 God sey, “I go ponish my shidren wey nor dey obey my kommand. Pipol wey dey do wetin dem like and enter agriment with wiked pipol kon dey do tins without my Spirit. Dem just dey add join dia sins.
ISA 30:2 Only dem go Egypt for proteshon kon beg Fero make e guide dem, even doh I nor send dem.
ISA 30:3 But na shame una go get from Fero proteshon, bikos Egypt pipol nor go fit help una at-all.
ISA 30:4 Aldo, Egypt leaders dey Zoan and dia ofisas dey kom from Hanes,
ISA 30:5 God go disgrace Israel pipol, bikos dis pipol nor fit help dem. Dem nor go fit help dem at-all, instead na shame and disgrace dem dey bring.”
ISA 30:6 Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.
ISA 30:7 Egypt pipol nor go fit help dem at-all and bikos of dis, I koll di land, “Nashon wey dey make mout, but dem nor get pawa.”
ISA 30:8 Naw, make yu go rite am down for dia present; rite am for one book so dat dem go fit keep am wait dia shidren-shidren make dem for know wetin happen.
ISA 30:9 Bikos dis pipol sturbon and dey lie well-well; dem bi shidren wey nor gri obey God law.
ISA 30:10 Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.
ISA 30:11 “Nor do good again, but make yu kom join us. Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”
ISA 30:12 Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey, “Una don rijet dis message kon bilive una pawa wey bi to opress and deceive pipol. Yes! Una really love una bad karata.
ISA 30:13 So na dis sin go distroy una. Una go bi like high old wall wey don krack and wey go soon fall and na wons e go fall.
ISA 30:14 E go skata for groun like pot wey break to pieces and nobody go fit pick or arrange am again.”
ISA 30:15 Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: “I wish sey una gri turn from sin kom meet mi kon dey wait with patient, I for diliver una; if una kwayet, dey wait mi, I go give una strent and pawa, but una nor gri wait.
ISA 30:16 Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’ and true-true, una go run. Una sey, ‘Wi go run with di horse wey fast pass,’ but doz wey dey porshu una, go fast pass una.
ISA 30:17 Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”
ISA 30:18 Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.
ISA 30:19 Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.
ISA 30:20 Aldo, God go give una sofa chop like food kon make una drink pain una; but E go still dey with una to tisha una. Una go si una tisha with una own eye.
ISA 30:21 Una go hear one vois dey tok from una back sey, “Na di korrect way bi dis, make una waka pass der,” weda una dey waka go rite or left.
ISA 30:22 Una go distroy una juju wey dem make with silva and gold. Una go trowey dem like rag wey dem take klean groun kon sey, “Make una take dem komot here.”
ISA 30:23 God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field.
ISA 30:24 Di melu and oda animals wey una take dey work for una field, go dey chop betta-betta food.
ISA 30:25 For dat time wen dem kill pipol well-well and di towas don fall, wota go dey flow kom from evry mountin and hill.
ISA 30:26 Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.
ISA 30:27 Si! God dey kom from far with strong vexnashon and great glory. E dey vex dey tok and en words bi like fire wey dey distroy tins.
ISA 30:28 Wen E shaut for war, e bi like river wey dey distroy tins or wey kover pesin rish en neck. E go shake di pipol like tray wey dem take dey separate rice from en kanda. E go put rope for dia mout kon distroy dem.
ISA 30:29 But una go sing just as una dey do wen una dey do festival for evening; una go happy like pesin wey dey blow trumpet go woship for di Oga God mountin; di God wey dey protet Israel.
ISA 30:30 God go shaut well-well kon fight with pawa. Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy, heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.
ISA 30:31 True-true, God vois go skata Assyria pipol, E go distroy dem with en rod.
ISA 30:32 Evry blow wey E give dem, Israel pipol go support am with music from dia trumpet and jita and E go attack dem with en swod.
ISA 30:33 Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.
ISA 31:1 Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!
ISA 31:2 God wise well-well! E dey do just as E tok. E go ponish wiked pipol and doz wey dey enkourage pipol to sin.
ISA 31:3 Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.
ISA 31:4 True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.
ISA 31:5 Just as bird dey fly round en house make e for protet en shidren, na so too God go protet and defend Jerusalem.”
ISA 31:6 God sey, “Israel pipol, una don sin and oppoz mi, but make una turn from sin kom meet mi!
ISA 31:7 Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.
ISA 31:8 “Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.
ISA 31:9 Dia king go run komot from en palis bikos of fear; dia ofisas go dey fear wen dem si God war flag.” Dis na God word; di One wey en fire dey burn well-well for Mount Zion.
ISA 32:1 Di time dey kom wen one king go rule well and di leaders go dey judge well too.
ISA 32:2 Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.
ISA 32:3 Dia eyes nor go dey blind and dia ears go dey listin well to hear wetin di pipol wont.
ISA 32:4 Dem nor go wiked again and dem go dey do tins and tok to dia pipol well.
ISA 32:5 Nobody go sey foolish pipol get sense and doz wey dey deceive odas, nobody go sey dem wise.
ISA 32:6 Foolish pipol dey tok anyhow and na wikedness full dia mind. Tins wey God nor like, na-im dem dey like to do and dem dey tok yuzles tins about di Oga awa God. Pipol wey dey hongry, dem dey make hongry kill dem more and doz wey nid wota, dem nor dey gri give dem wota drink.
ISA 32:7 Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.
ISA 32:8 But good pesin dey plan to do good tins and na-im karata dey save am.
ISA 32:9 Wimen wey dey enjoy life, make una listin to wetin I dey tok! Di wimen wey get heart well-well and nor kare about anytin, make una listin to mi:
ISA 32:10 “Una fit dey okay naw, but by dis time next year, una go dey hongry, bikos grapes nor go dey wey una go gada; una nor go even si any fruit chop.
ISA 32:11 Una dey enjoy life since and nor kare about anytin, but naw, make una shake dey fear! Make una pul una klot kon tie rag for una waist.
ISA 32:12 Make una kry, bikos dem don distroy una good land and una vineyards.
ISA 32:13 Make una kry well-well, bikos shuku-shuku and grass don grow kover di land. Make una kry for all di house and towns wey pipol for dey happy before.
ISA 32:14 Bikos dem don run leave dia strong town. Di town wey pipol bin full don turn empty place. Nobody dey stay dia hill and towas again and naw, na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.
ISA 32:15 Na so dis tins go bi until God go from heaven kon give us new life, den di desert go turn where fruit dey and di fruit tree go many like sey na forest.
ISA 32:16 Dat time, dem go dey judge and trit evribody well both for di desert and for di town
ISA 32:17 and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.
ISA 32:18 God pipol nor go worry again; peace go dey dia house and dem go dey save.
ISA 32:19 But even if dem distroy di forest kon skata di town,
ISA 32:20 di pipol go still dey happy, bikos wota go dey plenty for dem to plant dia seed and dia animals go dey save, bikos dem go si grass chop.”
ISA 33:1 Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
ISA 33:2 So my God, make Yu sorry for us, bikos na Yu wi put awa hope on. Make Yu dey protet us evriday kon save us from trobol.
ISA 33:3 Wen Yu fight for us, nashons dey run! Wen dem hear yor nois, dem dey run skata.
ISA 33:4 Awa enemies propaty dey skata like plant wey ant chop.
ISA 33:5 God dey great well-well! Yes, E dey stay for heaven. E dey judge Jerusalem pipol well-well.
ISA 33:6 Na-im dey make en pipol strong kon make dem dey save. E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am, E dey do all dis tins for.
ISA 33:7 Si, pipol wey dey ripresent kountries dey kry and doz wey dem send to go make peace, dey sorry for demsef.
ISA 33:8 Di main road dey empty, bikos nobody dey travel again. Kontries dey break di agriment wey dem make with each oda and pipol nor dey respet one anoda again.
ISA 33:9 Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.
ISA 33:10 God tell di nashons sey, “Naw, I go get up! I go show how my pawa big rish kon make una respet mi.
ISA 33:11 Una just dey make yeye plans and evritin wey una dey do, dey yuzles. Di air wey una dey breath, na fire wey go distroy una.
ISA 33:12 Una go skata like rocks wey dem dey burn take make lime; like shuku-shuku wey dey burn to ashes.
ISA 33:13 So make evribody wey dey near and far hear wetin I don do, so dat dem go know how my pawa bi.”
ISA 33:14 Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”
ISA 33:15 Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,
ISA 33:16 na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
ISA 33:17 E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well with one kingdom wey big and wide well-well.
ISA 33:18 Una go remember all di wahala wey una face before, den una go ask unasef, “Where dem rite dis tins put? Where di pesin wey dey hold di money? Where di pesin wey dey kount di towa?”
ISA 33:19 Una nor go ever si sturbon pipol wey go dey speak language wey una nor undastand again.
ISA 33:20 Instead, una go si Zion, di town where wi for dey celebrate awa festival. Una go si Jerusalem too! E go dey save well-well and pipol go stay der! E go bi like tent wey dem nor dey karry komot from where e dey; tent wey dem nor dey pul en peg from groun and en rope nor go kut.
ISA 33:21 True-true, God go rule for der as awa king. River wota go dey flow pass awa land. No war ship or big ship go drive pass am.
ISA 33:22 Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.
ISA 33:23 For dis time, all awa enemies ship rope don slak; di ship don weak well-well! Wi go seize all di propaty wey awa enemies sojas get kon divide dia propaty among doz wey nor fit waka.
ISA 33:24 Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”, di pipol wey dey der, God go forgive dem dia sins.
ISA 34:1 Pipol from evry nashon, make una kom! Make una gada kon listin. Make evribody for di world listin.
ISA 34:2 God dey vex for all di nashons and dia sojas. E go kill and distroy dem.
ISA 34:3 Nobody go beri dem; dem go rotin for groun. Dem go dey smell for evriwhere and dia blood go kover di mountins.
ISA 34:4 All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose and di stars go fall like dry leaf wey fall from vine or fig tree.
ISA 34:5 God dey ready with en swod for heaven and E go kut Edom; doz pipol wey E won kondemn and distroy.
ISA 34:6 Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.
ISA 34:7 God go kill dem with all dia animals. Blood go kover dia land and di pipol flesh go kover evriwhere.
ISA 34:8 God don plan di day wey E go revensh Edom pipol for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.
ISA 34:9 Edom rivers go turn black like shako and di land go turn to sulfur. Di whole kountry go black like shako too.
ISA 34:10 E go dey burn both for day and nite and smoke go dey kom out from am forever. Nobody go ever fit stay or travel pass di land from one generashon go rish anoda.
ISA 34:11 Na owls and ravens go dey stay di land. God nor go let am bear fruit again, just as e dey bear before wen God kreate di world.
ISA 34:12 En kings and leaders nor go get anywhere to koll dia kingdom again and all en ofisas go disappear.
ISA 34:13 Shuku-shuku go grow full dia farms; jackals and owls go dey stay for di town.
ISA 34:14 Na for der doz animals for desert go dey do meetin; wiked goat go dey koll demsef for der and na der too doz wiked animals for nite, go dey kom rest.
ISA 34:15 Wiked bird go build dia house, lay eggs, born dia shidren and kare for dem for der. Vulture go gada for der one-by-one.
ISA 34:16 So make una take time take read God book! No one among dis animals go miss and all of dem go get dia patina. God don kommand and en ensef go bring dem togeda with en Spirit.
ISA 34:17 Na God go divide di land give dem and E go give evribody di one wey rish am. Dem go stay for di land from one generashon go rish anoda one.
ISA 35:1 Make di desert and doz dry aria, happy. Make di wildaness happy kon grow well like lily flower!
ISA 35:2 Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.
ISA 35:3 Di hands and legs wey don taya, make una make dem strong.
ISA 35:4 Make una tell evribody wey nor get hope sey, “Make yu dey strong, nor fear at-all! God dey kom save yu and E go ponish yor enemies.”
ISA 35:5 Den blind eyes go open and doz wey nor dey hear, go hear word.
ISA 35:6 Pipol wey nor fit waka, go stand up dance and pipol wey nor fit tok, go dey shaut with happiness. River go dey flow kom from all di desert;
ISA 35:7 di hot groun go turn to lake and wota go kover all di dry land. Where wiked dogs bin dey stay, grass, reeds and straw go grow full der.
ISA 35:8 One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.
ISA 35:9 No lion go dey der and wild animals nor go pass dat place. Na di pipol wey God don save, go pass dat road.
ISA 35:10 Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.
ISA 36:1 For di fourteent year wen Hezekaya bi king for Judah, King Sennakerib for Assyria kon attack and seize all Judah strong town.
ISA 36:2 Den e kommand en offisa oga sey make e karry plenty sojas from Lakish go Jerusalem kon tell King Hezekaya sey make e surenda. So, di ofisas take-ova di road where di pipol for dey wosh and dry klot, near di Uppa Pool.
ISA 36:3 Den, Eliakim wey Hilkaya born, Shebna wey bi di kourt seketry and Joah wey bi Asaf pikin wey dey keep rekord, kom out kon go meet Assyria offisa wey di king send kom.
ISA 36:4 Di offisa tell Jerusalem pipol, “Make una tell Hezekaya sey, ‘Dis na wetin di great king for Assyria tok: “Wetin dey give yu dis mind?
ISA 36:5 Yu tink sey ordinary word fit do wetin soja pawa fit do? Who una tink sey go help una fight Assyria pipol?
ISA 36:6 Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”
ISA 36:7 Di Assyria ofisas still sey, “May bi una go tell mi sey, ‘Wi trust di Oga awa God.’ But nor bi en Hezekaya curse? Hezekaya nor skata all en shrine and altars kon sey evribody for Judah and Jerusalem go woship for only one altar for Zion?
ISA 36:8 I go make agriment with una bikos of di king. I go give una 2,000 horse, as long as una get who go ride dem.
ISA 36:9 Una sojas nor even dey di same rank with Assyria soja wey small pass, even if una bring Egypt shariot and sojas kom help una.
ISA 36:10 Na God kommand make mi kom here won distroy dis kountry so. Na God ensef tell mi sey, ‘Make yu go attack and distroy dis land.’ ”
ISA 36:11 Den Eliakim, Shebna and Joah tell di offisa, “Make yu speak Aramaik give us. Wi dey undastand am, make yu nor speak Hibru, bikos all di pipol wey dey di wall dey listin.”
ISA 36:12 Di offisa kon ansa, “Una tink sey na only di king and una three, di king send mi kom tell all dis tins? No! I still dey tell di pipol wey sidan for di wall, wey go soon chop dia shit kon drink dia piss, just as unasef go do.”
ISA 36:13 Den di ofisas stand up kon shaut for Hibru, “Make una listin to wetin Assyria king won tell una.
ISA 36:14 E dey warn una sey make una nor let Hezekaya deceive una, bikos Hezekaya nor go fit save una.
ISA 36:15 Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town?
ISA 36:16 “Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,
ISA 36:17 till di king go put una for one kountry wey bi like una own; where vineyard dey wey go give una wine and flower to take make bread.
ISA 36:18 “Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?
ISA 36:19 Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?
ISA 36:20 Wish time any kountry god don fit save en pipol from awa king? So, wetin make una tink sey una God go fit save Jerusalem?”
ISA 36:21 Di pipol no tok at-all, bikos King Hezekaya don tell dem make dem kwayet.
ISA 36:22 Den Eliakim, Shebna and Joah vex tear dia klot kon go tell di king wetin Assyria offisa tok.
ISA 37:1 As King Hezekaya hear di ripot, e vex tear en klot kon wear sak klot go God temple.
ISA 37:2 E send Eliakim wey bi di offisa wey dey kare for di palis, Shebna wey bi di kourt seketry and di senior priest go meet Profet Isaya wey bi Amos pikin and all of dem wear sak klot too.
ISA 37:3 Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.
ISA 37:4 Assyria king don send en offisa oga kon curse God. Make God wey bi yor God hear dis curse, so dat E go ponish di pipol wey curse am. So make una pray to God for all awa pipol wey remain.”
ISA 37:5 Wen Profet Isaya si Hezekaya message wey e send thru en savants,
ISA 37:6 e kon sey, “Make una tell di king: ‘Dis na wetin God tok: “Make una nor fear bikos of all di tins wey una hear and di curse wey Assyria king savant curse mi.
ISA 37:7 Si, mi God go kontrol en mind; e go hear one news wey go make am run go back to en kountry, den I go kill-am for der.” ’ ”
ISA 37:8 Wen Assyria offisa oga kom back from Jerusalem kon hear sey di king don komot from Lakish go fight against Libnah town wey near dem, e kon go meet and tok to am for der.
ISA 37:9 Dem kon tell Assyria sojas sey, Egypt sojas wey King Tirhakah for Sudan dey lead, dey kom attack dem. As di king hear dis tin, e kon send leta go give King Hezekaya
ISA 37:10 for Judah sey, “Di God wey yu dey trust don tell yu sey I nor go fit kill yu, but make yu nor let dat one deceive yu.
ISA 37:11 Yu don hear wetin Assyria king dey do any kountry wey e won distroy. Yu tink sey yu fit eskape from am?
ISA 37:12 Na my papa dem distroy Gozan, Haran and Rezef town and dem kill Eden pipol for Telassar and no god fit save dem.
ISA 37:13 Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”
ISA 37:14 Den, King Hezekaya kollect di leta from di messenja, read am kon take am go put for God altar for di temple,
ISA 37:15 den e pray,
ISA 37:16 “Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.
ISA 37:17 Naw, my Oga God, make Yu hear and si wetin dey happen to us. Make Yu listin to all di tins wey King Sennakerib dey use take curse Yu wey bi God.
ISA 37:18 “Oga God, all of us know sey, Assyria king don distroy plenty nashons kon skata dia lands;
ISA 37:19 e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.
ISA 37:20 Naw, Oga wey bi awa God, make Yu save us from Assyria pipol, so dat all di nashons for di world go know sey, na Yu bi God.”
ISA 37:21 Den Profet Isaya send message go tell King Hezekaya about en prayer sey,
ISA 37:22 “God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.
ISA 37:23 “ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.
ISA 37:24 Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest
ISA 37:25 kon dig well and drink betta wota for pipol land. Yu sey wons yor soja leg tosh River Nile, di wota go dry at wons.
ISA 37:26 So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since? And naw, I don do am; bikos na mi give yu pawa to take skata all di towns wey dem protet.
ISA 37:27 Doz wey dey stay der nor bin get pawa and fear dey katch dem. Dem bi like grass for field or grass wey dey grow on-top roof wey east wind go soon blow komot.
ISA 37:28 I know evritin about yu; di tins wey yu dey do, di place wey yu dey go and how yu dey plan against mi.
ISA 37:29 Di way yu dey karry body up and make mout, don rish my ear and naw, I go hook yor nose and yor mout kon take yu go back thru where yu pass kom.’ ”
ISA 37:30 Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.
ISA 37:31 Doz wey go survive for Judah, go grow like plant wey en rut deep well-well kon produce betta fruit.
ISA 37:32 Pipol go survive for Jerusalem and Mount Zion, bikos God don sey dis tins must happen.
ISA 37:33 So dis na wetin God tok about Assyria king: ‘E nor go enter dis town or shot one arrow against am. No soja wey karry shield go kom near di town and dem nor go build anytin take surround am.
ISA 37:34 E go pass di same road wey e take kom go back and e nor go enter dis town.
ISA 37:35 I go defend and protet dis town, bikos of my honor and wetin I promise David, my savant.’ ”
ISA 37:36 So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!
ISA 37:37 Den King Sennakerib for Assyria kon go back to Nineveh.
ISA 37:38 One day wen e dey woship for Nisrok wey bi en god temple, Adrammelek and Shareza wey bi en sons kon shuk am die with dia swod, den dem run go Ararat land. En pikin Esarhaddon kon take-ova as king.
ISA 38:1 For dat time, King Hezekaya sick and e don nearly die. So Profet Isaya go meet and tell am, “God sey make yu range yor propaty well, bikos yu go die. So make yu dey ready to die.”
ISA 38:2 Den King Hezekaya turn face di wall kon bigin pray sey:
ISA 38:3 “Oga God, make Yu remember sey I dey faithful and loyal as I dey serve Yu. I always dey do wetin Yu wont make I do.” Den e kon bigin kry well-well.
ISA 38:4 So God kommand Profet Isaya sey,
ISA 38:5 “Go back go meet King Hezekaya kon tell am, ‘Mi wey bi yor papa David God don hear yor prayer and si yor tears; so I go let yu stay for anoda fifteen years.
ISA 38:6 I go save yu and Jerusalem pipol from Assyria king and I go kontinue to protet di town.’
ISA 38:7 “And dis go bi sign to show sey God go do wetin E promise.
ISA 38:8 For di place wey Ahaz build, God go make di sun shadow go back ten times.” So di shadow kon go back ten times.
ISA 38:9 Afta King Hezekaya don well, e kon rite dis song take praiz God:
ISA 38:10 E sey, “I feel sey as I don live only half of my life, I go die and I nor go si di rest of my years again.
ISA 38:11 I bin tink sey, I nor go ever si God or anybody wey dey alive again for dis world.
ISA 38:12 Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.
ISA 38:13 I dey kry evry nite with pain like sey lion dey break my bones, bikos I tink sey God won end my life.
ISA 38:14 I nor fit shaut and I dey weak kon dey do like dove. My eyes don taya to dey look heaven. So God, make Yu save mi from all dis trobol.
ISA 38:15 But wetin I go tok? God don do as E kommand. All my life, I go dey waka small-small bikos fear dey katch mi.
ISA 38:16 My Oga God wey get pawa, yor kommand dey give pesin life; so make Yu give mi life again.
ISA 38:17 Di pain wey I go thru na for my own good. Yu save my life from all di wahala kon forgive mi my sins.
ISA 38:18 Nobody wey don die go fit praiz Yu. Pipol wey don die nor go fit know how Yu good rish.
ISA 38:19 Na pipol wey dey life fit praiz Yu, just as I dey praiz Yu naw. Papa dem dey tell dia shidren how Yu dey faithful rish.
ISA 38:20 So Oga God, Yu don heal mi. I go play harp to take sing and praiz Yu; I go sing praiz for yor temple as long as I dey alive.”
ISA 38:21 Den Profet Isaya kon tell di king, “Make yu melt fig kon put am for di boil for yor body and yu go dey okay.”
ISA 38:22 Den King Hezekaya ask, “Wetin bi di sign to show sey I go fit go di temple again?”
ISA 39:1 For dat time, King Merodak-Baladan wey bi Baladan pikin, for Babilon kon hear sey King Hezekaya dey sick since, so e send leta and gifts go gi-am.
ISA 39:2 King Hezekaya welkom di messenjas kon show dem en propaty, silva, gold, spices, perfumes and evritin wey en sojas dey use for war. E nor get anytin for en store room or kingdom wey e nor show dem.
ISA 39:3 Den Profet Isaya go meet King Hezekaya kon ask, “Where dis men from kom and wetin dem wont?” King Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon wey far well-well.”
ISA 39:4 Di Profet ask, “Wetin dem si for di palis?” Di king ansa, “Dem si evritin, e nor get anytin for di store room wey I nor show dem.”
ISA 39:5 Profet Isaya kon tell di king, “God wey get pawa sey,
ISA 39:6 ‘Time dey kom wen dem go karry evritin wey yor grand-grand papa dem keep kon rish naw go Babilon and nor-tin go remain.
ISA 39:7 Dem go still karry some of yor own shidren-shidren go do slave work for di king palis for Babilon.’ ”
ISA 39:8 King Hezekaya undastand sey, as long as e dey alive, peace go dey for di town, so e ansa, “Di message wey yu give mi from God so, dey good.”
ISA 40:1 Awa God sey, “Make yu konfort my pipol! Konfort dem well-well!
ISA 40:2 Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.
ISA 40:3 One vois dey kry sey, Prepare one road for di wildaness for God! Make una klear di road for di desert for awa God!
ISA 40:4 God go raiz-up evry valley and E go level evry mountin and hill. All di bend-bend road go strait and di rof place go smooth.
ISA 40:5 Den God glory go kom out and evribody go si am, bikos God don tok am with en own mout.”
ISA 40:6 One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!” So I ask, “Wish message I go prish?” Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass; let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.
ISA 40:7 Grass dey dry and flowers dey fade wons God send strong breeze go blow dem. Na so too pipol nor dey last pass grass.
ISA 40:8 Yes, di grass go dry and flower go fade, but awa Oga God word go dey forever.”
ISA 40:9 So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
ISA 40:10 God wey dey mighty dey kom rule with pawa and E dey bring di pipol wey E don save with am.
ISA 40:11 E go kare for en animals just as shepad dey do. E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand; E go lead and guide dem.
ISA 40:12 E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am? Abi who fit measure di sky? Abi anybody don fit weigh all di san for di eart or weigh di mountins and hills with skale?
ISA 40:13 E get anybody wey fit tell or tish God wetin E go do? Abi pesin dey wey go advise God?
ISA 40:14 Who God dey go ask make E for fit undastand how E go do tins?
ISA 40:15 Si, di nashons nor mean anytin to God, dem bi like one drop of wota. Di island wey dey for far nor heavy rish dust for God hand.
ISA 40:16 All di animals wey dey for Lebanon forest nor rish to take offa sakrifice for God and all di trees nor plenty rish to take make fire for di sakrifice.
ISA 40:17 All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.
ISA 40:18 Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?
ISA 40:19 E nor bi like juju wey man make or di one wey doz wey dey karve wood kover with gold or put silva.
ISA 40:20 Pesin wey nor fit buy silva or gold go use wood wey nor go rust and e go find who sabi di work make e help am make image wey nor go skata.
ISA 40:21 Una nor know? Dem neva tell una since? Una neva hear how di world take start?
ISA 40:22 Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.
ISA 40:23 Na-im dey make rulers rule with pawa kon still bring dem down.
ISA 40:24 Dem bi like yong plants wey just dey grow kom out wey pipol rut trowey. Wen God send en breeze kom, di flower dey dry and blow komot like grass.
ISA 40:25 Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?
ISA 40:26 Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
ISA 40:27 So, Israel pipol! Why una dey komplain sey God nor know una trobols or kare if una dey sofa at-all?
ISA 40:28 Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.
ISA 40:29 E dey give strent and pawa to pipol wey dey weak.
ISA 40:30 Even yong pipol go taya and strong yong men go kwik too.
ISA 40:31 But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.
ISA 41:1 God sey, “Una wey dey for far land, make una listin to mi! Make una kom meet mi make I give una new pawa! Make una kom tok to mi; make wi kom togeda kon setol di matter.
ISA 41:2 Na who raiz di raitious Pesin kom from east kon make am stand and rule ova nashons and kings? With en swod, e turn dem to dust and with en bow, e make dem bi like grass wey breeze dey blow.
ISA 41:3 E porshu and pass dem and e nor wound at-all. Yes! E dey kom with full speed.
ISA 41:4 So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi? Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.
ISA 41:5 Pipol from far place si wetin I do and fear katch dem; di whole eart dey shake; all of dem gada dey kom fight.
ISA 41:6 Dem dey enkourage and tell each oda sey, ‘My broda, nor fear; make yor heart strong.’
ISA 41:7 Di karpenters among dem dey enkourage doz wey dey make gold and di man wey dey karve di juju dey tell di one wey dey nail am togeda sey, ‘I like as yu nail am strong so, bikos e nor go fall.’
ISA 41:8 “But Israel na my savant! Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;
ISA 41:9 pipol wey I koll and bring back from where di world for end kon sey, ‘Una bi my savant. I don choose una and I nor go rijet una.’
ISA 41:10 So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
ISA 41:11 Pipol wey dey vex with una, go know how pesin dey shame rish wen dem don defeat am. Pipol wey dey fight against una, go die
ISA 41:12 and dem go disappear komot from dis eart.
ISA 41:13 Na mi bi di Oga wey bi una God and I dey enkourage una sey, ‘Make una nor fear, bikos I go help una.’ ”
ISA 41:14 God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
ISA 41:15 I go make una bi like new swod wey get sharp korna. Una go distroy all una enemies and di mountins and hills go skata for groun like dust.
ISA 41:16 Una go blow dem and breeze go skata and karry dem go. Una go dey happy, bikos na mi bi una God, den una go praiz mi wey bi Israel God wey dey holy.
ISA 41:17 Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota bikos dia trot don dry, den mi, wey bi God go ansa dem. Israel God nor go ever abandon dem.
ISA 41:18 I go make river flow from dry hill and wota go flow for valley. I go turn di desert and di dry land to where wota full.
ISA 41:19 I go make cedar, akacia, myrtle and olive trees grow for di desert. Forest wey pine, junipa and cypress trees dey, go grow for dry land where tree nor suppose grow.
ISA 41:20 Pipol go si dis tins and dem go know sey, na mi wey bi God, do am. Den dem go undastand sey, na Israel God wey dey holy, make all dis tins happen.”
ISA 41:21 God wey bi Israel pipol king sey: “Di gods for di nashons, make una tok wetin dey una mind. Make una kom defend unasef!
ISA 41:22 Make una tell us wetin go happen, so dat wi go know before e happen. Make una tell us di tins wey una don tok before, so dat wi go shek dem kon si as dem go take happen. Abi una go tell us about wetin go happen for future?
ISA 41:23 Make una tell us how di future go bi, den wi go know sey una bi god! Make una do sometin wey dey good or wey dey bring wahala. Make una do tins wey go make us fear!
ISA 41:24 Una with evritin wey una dey do, nor mean anytin. Na yeye pipol dey woship una!
ISA 41:25 I don choose one pesin from east, I go bring am kon attack una from di nort and e go mash una just as pesin wey dey mold tins, dey mash klay.
ISA 41:26 Make wi know who tok am before e happen, so dat wi go know sey di pesin dey rite? True-true, nobody among una tok am! True-true nobody among una sey na so e go bi! True-true, nobody even hear wen una dey tok!
ISA 41:27 Na mi God first tell Zion sey, ‘Dis na wetin go happen.’ I send betta news go Jerusalem sey, ‘Una pipol dey kom! Dem dey kom house back!’
ISA 41:28 Wen I look all di gods, no one get anytin to tok; no one among dem fit ansa di kweshon wey I ask dem.
ISA 41:29 All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all. Di juju dem dey weak and konfuse and dem nor get pawa at-all.”
ISA 42:1 God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
ISA 42:2 E nor go shaut or make nois or dey tok waka for strits.
ISA 42:3 E nor go break di wood wey bend or lite lantan wey nor good. En good judgement go dey di whole world forever.
ISA 42:4 E nor go luz hope or start to fear. E go bring betta judgement kom evriwhere for di world and pipol for far-far land, dey wait make E kom tish dem.”
ISA 42:5 God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,
ISA 42:6 Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.
ISA 42:7 Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.
ISA 42:8 Na mi bi God and na my name bi dat; I nor go share my glory with anybody or let juju follow mi share my praiz.
ISA 42:9 “True-true, di tins wey I bin tok, don happen naw. So, I go tell una new tins naw, even before dem go start to happen.”
ISA 42:10 Make una sing new song to God! Make evribody for di world sing praiz God. Una wey dey drive on-top di sea and evry oda tins wey E kreate for inside, make una sing praiz am. All di far land and doz wey dey der, make una praiz am.
ISA 42:11 Make all di desert and en towns praiz God; Make Kedar pipol praiz am! Make doz wey dey stay for Sela town shaut dey happy on-top di mountins!
ISA 42:12 Make di pipol wey dey stay far, give God praiz and glory kon tok as E good rish!
ISA 42:13 God dey go fight war like strong soja; E dey ready to fight. E go shaut. Yes! E go shaut for war kon distroy and win en enemies.
ISA 42:14 God sey, “I kwayet since and I nor ansa my pipol, but di time to tok, don rish. Just as woman wey won born dey shaut, na so too I dey shaut naw.
ISA 42:15 I go distroy di hills and mountins kon make di grass and trees dry. I go turn di river to desert kon dry all di place wey wota from dey flow.
ISA 42:16 I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
ISA 42:17 But for all of una wey trust juju, wey dey koll image una gods, dem go sofa and disgrace una.”
ISA 42:18 God sey, “Una wey nor dey hear word, make una listin! Una wey nor dey si, make una look well-well!
ISA 42:19 E get anybody wey blind pass my savant or deaf pass di messenja wey I send?
ISA 42:20 Israel pipol, una don si many tins, but wetin dem mean to una? Una get ear to take hear, but wetin una don really hear?”
ISA 42:21 God wont make dem know how E dey judge thru en raitiousness and how E dey show am.
ISA 42:22 But naw, dem don tif all en pipol tins; lock dem undagroun kon hide dem for prison. Dem tif from dem kon karry all dia tins komot and nobody dey to save dem.
ISA 42:23 Naw, who among una go gri listin to dis tin? From naw go, una go gri listin with kare?
ISA 42:24 Who sell Israel give di tif dem? Na God ensef wey wi sin against! Wi nor dey live awa life just as E wont or obey wetin E tish us.
ISA 42:25 So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.
ISA 43:1 Naw, God wey kreate una sey, “Make una nor fear, I go save una. I don koll una by una name and una bi my pipol!
ISA 43:2 Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
ISA 43:3 Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.
ISA 43:4 I go give out many nashons, so dat una go dey save. I value una well-well and I love and honor una.
ISA 43:5 Make una nor fear, bikos I dey with una! I go bring una pipol from east and west kom house back.
ISA 43:6 I go tell di nort make dem let dem go and di sout nor go hold dem for der. Make my pipol kom from evriwhere for di world.
ISA 43:7 Dem bi my own pipol and I kreate dem, so dat dem go give mi glory.”
ISA 43:8 God sey, “Gada my pipol togeda. Dem get eyes, but dem nor dey si. Dem get ear, but dem nor dey hear!
ISA 43:9 Make all di nashons gada togeda and make dem bring di pipol kom: Wish one of dia gods go fit tok wetin go happen for future? Who among dem bin tok wetin dey happen naw? Make dem bring dia witness wey go sey dem dey rite or di pipol wey go kon tell us sey dem tok di trut.
ISA 43:10 Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.
ISA 43:11 Yes! Na only mi bi God; di only One wey dey save una.
ISA 43:12 I first tok wetin go happen and den, I kom save una and know oda god don do like dis before. Yes! Na una bi my witness.
ISA 43:13 Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”
ISA 43:14 Israel God wey dey holy, wey save una sey, “Bikos of una, I send sojas go Babilon kon break di town gate and di pipol happiness kon turn kry.
ISA 43:15 Na mi bi una God wey dey holy. Israel pipol, na mi kreate una and na mi bi una king.”
ISA 43:16 God wey make road pass di sea and where wota dey,
ISA 43:17 Di One wey lead strong sojas go distroy Babilon, dia shariot and dia sojas. Dem fall for groun and dem nor go raiz again; dem dey go up like smoke wey dey kom out from lantan!
ISA 43:18 But God sey, “Make una nor tink about wetin dey happen or put una mind for wetin don happen before.
ISA 43:19 But naw, I go do new tin; e go happen and una go si am! I go make road for di wildaness kon give una plenty wota for der.
ISA 43:20 Even bad animals go honor mi; jackals and ostrich go praiz mi wen I go make river flow for di desert, so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.
ISA 43:21 Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”
ISA 43:22 God sey, “Israel pipol, una bin taya for mi; una nor gri woship mi.
ISA 43:23 Una nor offa sheep for mi as ofrin; una nor gri honor mi with una sakrifice. I neva force una to serve mi with una ofrins or force una to give mi incense.
ISA 43:24 Una neva buy any incense for mi or give mi di fat for una animal as ofrin. Yet una dey wahala mi with una sins kon make mi dey vex bikos of una yeye ways.
ISA 43:25 But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.
ISA 43:26 Make una remind mi of di good wey una do; make wi tok di matter togeda; make una tok as una take good.
ISA 43:27 Una grand-grand papa dem wey dey before, kommit sin. Una leaders sin against mi and una rulers stain my temple with blood.
ISA 43:28 So I bring wahala kom Israel; I do am, so dat dem go curse and ponish my pipol.”
ISA 44:1 God sey, “Make una listin, Israel pipol wey bi my savant and Jakob shidren-shidren wey I choose.”
ISA 44:2 Dis na wetin God tok, “Na mi kreate and form una for una mama belle kon help una, so make una nor fear, bikos una bi my savant; di pipol wey I choose and love.
ISA 44:3 I go give una wota for dry land kon make wota flow pass where wota nor dey. I go put my Spirit for una shidren body kon bless una shidren-shidren.
ISA 44:4 Dem go grow like grass for di field, like tree wey dey where wota dey flow pass.
ISA 44:5 Den, one among dem go sey, ‘I bi God own.’ Anoda one go sey ‘I bi Jakob pikin.’ and anoda one go rite God name put for en hand kon sey, I dey among God pipol and my name na Israel.”
ISA 44:6 God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.
ISA 44:7 E get anybody wey bi like mi? Make e tok am! Make e kom out kon make mout for my front about wetin don happen since I kreate dis world and wetin go still happen! Yes, make e tok wetin go happen.
ISA 44:8 So my pipol, make una nor fear or shake! Una know sey from biginnin kon rish naw, I always dey tok di tins wey go happen and una bi my witness. E get any oda god apart from mi? E nor get any oda god, wey get pawa. I neva si or hear about any one?
ISA 44:9 “Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.
ISA 44:10 Na only fool go make en own god – yeye god wey nor go fit help or fight for am.
ISA 44:11 Si, shame go follow evribody wey dey woship dat god, bikos na human being make am. So make dem kom make wi judge di kase, den una go si sey, fear go katch dem and dem go disgrace demsef.
ISA 44:12 Blacksmit dey melt iron for fire. E go nak am with hammer until e get di shape wey e wont and na en strong hand e take dey make am. Wen e hongry, e go kon weak. If e nor si wota drink, e fit faint.
ISA 44:13 Na so too, karpenter dey measure wood kon draw as e wont make e bi, den e go karve am like human being and put am for en shrine.
ISA 44:14 E kut cedar tree, kollect oak or cypress tree and oda tree from forest. E plant cedar seed and rain kon make am grow,
ISA 44:15 den pesin go kut and take am make fire kon warm ensef. Yes! E go make fire from am kon bake bread too! E still use some take make juju kon woship and bow to am.
ISA 44:16 E use some of di wood take make fire and roast meat chop beleful. Den e go warm ensef kon sey, ‘My body dey warm bikos of di heat from di fire!’
ISA 44:17 Den e use di wood wey remain take make juju kon bow woship and pray gi-am sey, ‘Na yu bi my god, so make yu kom save mi!’
ISA 44:18 Dis pipol nor get sense and dem nor know wetin dem dey do, bikos dem don klose dia eyes and mind against di trut.
ISA 44:19 Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’
ISA 44:20 E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
ISA 44:21 God sey, “Israel pipol, make una remember sey una bi my savant and I nor go ever forget una.
ISA 44:22 I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”
ISA 44:23 Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
ISA 44:24 Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.
ISA 44:25 Na mi dey fool pipol wey dey si vishon kon make dia work taya dem. I dey shange wise pipol advise to anoda tin kon turn dia wisdom to foolishness.
ISA 44:26 But wen my savant tok wetin go happen; wen I send my messenjas go tell una wetin I plan, I dey make doz plans, happen. I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again and dem go ribuild Judah town. Even doh dem skata am before, I go raiz am up again.
ISA 44:27 Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.
ISA 44:28 Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”
ISA 45:1 Dis na wetin God tell Cyrus wey E choose, wey go use en rite hand distroy nashons, remove kings from pawa kon open gates so dat dem nor go klose am again:
ISA 45:2 “I go-go for yor front kon make hills and mountins smooth. I go break bronze gates kon skata dia iron protetor.
ISA 45:3 I go give yu betta tins wey dem hide for dark and sekret place. Den yu go know sey, na mi bi God! Israel pipol God, wey koll yor name.
ISA 45:4 I koll yu bikos of Jakob shidren-shidren wey bi my savant and Israel pipol wey I don choose. I don give una great honor, even doh una nor know mi well.
ISA 45:5 Na mi bi God, no oda god dey wey bi like mi. I give una pawa, even doh una nor know mi well.
ISA 45:6 I do dis tins make evribody for di world, from one end go rish di oda, know sey na mi bi God and e nor get anoda god wey bi like mi.
ISA 45:7 Na mi kreate both lite and darkness; di Pesin wey dey bring blessing and wahala and na mi wey bi God, dey do all dis tins.
ISA 45:8 I go send viktory kom from di sky like rain, so make di eart open and receive am; so dat salvashon and korrect judgement, go grow. Mi, wey bi God, go make dis tins happen.”
ISA 45:9 E nor go betta for di pesin wey dey argue with di Pesin wey kreate am! Pesin wey bi like ordinary pot for where oda pots dey for groun. Klay fit tell who dey use am sey, “Wetin yu dey do?” Abi di pot wey yu dey make fit sey, “Yu nor know work at-all?”
ISA 45:10 E nor go betta for pikin wey ask en papa and mama sey, “Wetin una tink sey una born so?”
ISA 45:11 Di Oga wey bi Israel pipol God wey dey holy; di Pesin wey dey make awa future betta, don sey, “Yu nor get rite to kweshon mi about my shidren or tell mi wetin I go do!
ISA 45:12 Na mi bi di Pesin wey kreate di eart and na mi kreate di pipol wey dey stay inside. Na my pawa I take stresh di heavens out kon kontrol di sun, moon and di stars.
ISA 45:13 I go make Cyrus take akshon, I go make all en road strait. E go ribuild my town kon free my pipol wey dem karry go anoda land and nobody go pay or bribe am.”
ISA 45:14 God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”
ISA 45:15 True-true, na Yu bi Israel God and Savior and Yu bi God wey nor dey show yorsef.
ISA 45:16 Pipol wey dey make juju, go shame and disgrace go follow dem. All of dem go waka go with disgrace.
ISA 45:17 But God go save Israel and dia viktory go bi forever. Nobody go ever disgrace God pipol again.
ISA 45:18 God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.
ISA 45:19 I nor dey tok for sekret or for di dark place for di eart. I neva ever sey, ‘Jakob shidren just dey follow mi for nor-tin.’ Mi wey bi God dey tok di trut. Yes! I dey tok wetin dey rite.”
ISA 45:20 God sey, “Una wey survive for di nashons, make una gada kom! Pipol wey dey waka for evriwhere with di wood juju wey dem dey serve kon dey pray give oda gods wey nor fit save dem, nor know anytin at-all!
ISA 45:21 So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.
ISA 45:22 Make evribody for di world turn kom meet mi naw and una go dey save, bikos na mi bi di only God wey dey.
ISA 45:23 Wetin I promise una, na true and nobody go fit shange am. Evribody go kom knee down for my front den promise sey dem go respet and obey mi.
ISA 45:24 Dem go sey, ‘Yes! Na only God get pawa to save pipol and anybody wey hate am, na disgrace go follow dem.’
ISA 45:25 Dem go bless and praiz Israel pipol, bikos of di Oga awa God.”
ISA 46:1 “Bel and Nebo town don fall. Dem pak dia juju on-top donkey and naw, di juju too heavy for di donkey to karry.
ISA 46:2 Di juju wey stand before don fall; dem nor fit save diasef and dem don karry di juju dem go as slave!
ISA 46:3 So Jakob shidren-shidren, make una listin; una wey remain for Israel, pipol wey I dey kare for, since dem born una.
ISA 46:4 Even wen una don old kon get white hair, I go still dey kare for una. Na mi kreate una, so I go support, help and save una.”
ISA 46:5 God sey, “Na who una fit take kompare mi? Make una tell mi, abi e get anybody wey fit bi like mi?
ISA 46:6 Pipol dey pour gold from dia bag kon measure dia silva. Dem go hire pesin wey go use di gold make juju for dem and den, kon woship am.
ISA 46:7 Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala.
ISA 46:8 Una wey dey tok against God, make una remember and tink of all wetin God don do.
ISA 46:9 Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.
ISA 46:10 I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.
ISA 46:11 I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.
ISA 46:12 So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi.
ISA 46:13 I dey kom judge and diliver my pipol. E nor go tey again and di time to save dem don near. I go save Jerusalem kon honor Israel pipol.”
ISA 47:1 “Babilon, kom down from yor throne and sidan for groun! Bikos from naw go, nobody go ever sey yu dey soft and tenda again.
ISA 47:2 Karry grindin stone kon bigin grind korn! Remove di klot wey yu take kover face and pul yor fine klot komot, den make yu pak yor skirt up as yu dey cross di river!
ISA 47:3 Pipol go si yor nakednes and shame go katch yu well-well, bikos I go revensh and I nor go sorry for yu.”
ISA 47:4 Awa Savior – di Oga God wey dey lead heaven sojas, naim bi en name; di Holy One for Israel.
ISA 47:5 “Babilon, sidan for darkness and make yu kwayet, bikos pipol nor go koll yu kween again!
ISA 47:6 I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.
ISA 47:7 Yu sey, ‘I go bi kween forever.’ But yu nor tink about dis tins or tink about wetin go happen.
ISA 47:8 Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’
ISA 47:9 But dis tins go happen to yu at wons; yor shidren and husband go die for di same day and yor majik nor go fit help yu.
ISA 47:10 Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’
ISA 47:11 So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.
ISA 47:12 Naw, make yu dey use yor majik well-well; majik wey yu dey use since dem born yu. May bi e fit help yu or yu fit use am porshu trobol!
ISA 47:13 Even all di many advise wey dem advise yu don make yu weak well-well. Yor pipol wey dey read di star and doz wey dey tok as weda go bi, make dem kom out kon save yu from wetin go soon happen to yu.
ISA 47:14 Si! Dem bi like grass wey fire burn trowey! Dem nor even fit save demsef, from di fire wey too hot for dem. Wen di weda kold, dem nor get fire to take warm demsef or di one dem go sidan near.
ISA 47:15 All yor friends wey use dey do business with since yu bi small pikin, go turn leave yu and nobody go kom help yu.”
ISA 48:1 Jakob shidren-shidren, make una listin to mi. Una wey bi Israel pipol wey kom from Judah tribe: pipol wey swear with God name sey, “Na Israel God wi dey woship,” but una nor mean wetin una dey tok.
ISA 48:2 Una wey sey una kom from di holy town and dey put una hope for Israel God wey bi di Mighty God.
ISA 48:3 God sey, “I dey tok about di tins wey go happen before e happen. Den na wons I do dem and dem kon happen.
ISA 48:4 Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.
ISA 48:5 So, I don tell una about dem since, even before dem happen, I don tell una, so dat una nor go sey na una juju and image make dem happen.
ISA 48:6 Una don hear and si evritin wey I tok sey go happen. Una go fit deny sey I nor tell una before? From naw go, I go tell una new tins wey go happen, wey una neva hear or know about before.
ISA 48:7 I just kreate dem naw, nor bi tins wey dey before and una neva hear about dem until today. So una nor go fit sey, ‘Yes! Wi know about dem before!’
ISA 48:8 Una nor dey hear or undastand; na since dem born una, una ear block. Yes, I really know how una wiked and sturbon rish and na wiked pikin dem dey koll una since dem born una.
ISA 48:9 But bikos of my name, I nor gri ponish una; bikos of my praiz, I nor gri distroy una at-all.
ISA 48:10 Naw, make una si as I don klean una and nor be like silva; but na betta sofa and wahala I take test and klean una.
ISA 48:11 Na bikos of mi, I dey do am. Yes! I dey do all dis tins bikos of mi. I nor go fit let una spoil my name. I nor go let anybody share my glory with mi.
ISA 48:12 Jakob shidren-shidren, make una listin to mi! Israel pipol wey I don koll, na mi bi God: na mi bi di first and na mi still bi di last.
ISA 48:13 Na my own hand I take make di eart foundashon kon spread di heavens with my rite hand and wen I koll dem, all of dem dey stand kom togeda.
ISA 48:14 So, make all of una gada kon listin to mi! Wish one among una juju don tell una all dis tins before? Di sojas wey God choose go do wetin E plan against Babilon.
ISA 48:15 Mi! Yes mi, wey bi God, don tok; yes I don koll am, I go bring am kom and e go do wetin I tell am sey make e do, well.
ISA 48:16 So make una kom near mi and listin to wetin I dey tok: ‘Since I start to tok, I nor hide dey do am; so wen e go happen, I go dey here.’ And naw, Oga God wey get pawa don send mi with en Spirit.
ISA 48:17 God wey save una, di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok: ‘Na mi bi di Oga una God, di Pesin wey dey tish una wetin dey good. Di One wey dey show una di road wey una go follow.
ISA 48:18 If to sey una just gri listin to my kommand, una peace for bi like river and una raitiousness for bi like wave for sea.
ISA 48:19 Una shidren-shidren for plenty like san-san, like korn wey dem nor go fit kount; nobody go fit remove dia name or distroy dem from my present.’
ISA 48:20 So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’
ISA 48:21 Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert; E tear rock open, Yes! E make wota flow kom out from di rock.
ISA 48:22 Oga God sey, ‘Wiked pipol nor go ever get peace.’ ”
ISA 49:1 Una wey dey stay for far-far land, make una listin to mi! Before dem born mi, God don koll mi. Wen I dey my mama belle, God don already know my name.
ISA 49:2 E make my words sharp like swod and betta arrow wey E fit use anytime kon hide and protet mi with en hand.
ISA 49:3 E tell mi sey, “Israel, yu bi my savant and pipol go praiz mi, bikos of yu.”
ISA 49:4 So I ansa, “I don work well-well, yet my work nor mean anytin! I use all my pawa, but I nor gain anytin.” But I still bilive sey, God go defend and reward mi for evritin wey I don do.
ISA 49:5 And naw, Oga God sey, na mi kreate and form yu from yor mama belle as my savant, so dat yu go bring Jakob, my pipol kom back to mi kon gada Israel togeda. Dis na bikos Oga God don honor mi and na-im bi my strent.
ISA 49:6 God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”
ISA 49:7 God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
ISA 49:8 God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.
ISA 49:9 I go tell doz wey dey prison sey, ‘Make una kom out!’ And doz wey dey for darkness, ‘Make una kom enter lite!’ Dem go bi like sheep wey dey chop grass for hill.
ISA 49:10 Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
ISA 49:11 I go turn all my mountins to betta road kon prepare road for di hills, so dat my pipol go fit travel pass.
ISA 49:12 Si, my pipol go kom from far; some from nort, west and from Egypt wey dey sout.”
ISA 49:13 So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
ISA 49:14 But Jerusalem pipol sey, “God don abandon us! Di Oga awa God don forget us.”
ISA 49:15 Den God ansa, “E get any woman wey fit forget en own pikin wey e born? But even if mama fit forget dia pikin, I nor go ever forget una.
ISA 49:16 Si, I don rite una names for my hand, una face go always dey my mind.
ISA 49:17 Make una shidren hurry kom. Make doz wey dey distroy, run from una.
ISA 49:18 Make una look round kon si wetin dey happen! Make all una sons gada kom meet una! Naw God dey sey, as long as una shidren dey alive, dem go bi like pomade for una body; una go wear dem like di gown wey woman wey won marry dey wear.
ISA 49:19 Una kountry skata and evribody bin run komot der, but naw, e go dey too small for una pipol. And doz wey leave una wen una dey face wahala, God go remove dem from una forever.
ISA 49:20 Di shidren wey dem born wen una dey sofa, go tell una one day sey, ‘Dis land too small, wi wont more house wey wi go stay!’
ISA 49:21 Den una go tell unasef sey, ‘Who give us all dis shidren? Wi know sey dem kill awa shidren kon karry di rest go as slave. Na only wi dey, so where all dis shidren from kom? Na who born dis shidren? Who train dem for us?’ ”
ISA 49:22 Awa Oga God tell en pipol sey, “Si, I go lift my hand to di nashon kon tell di pipol my laws; dem go karry una shidren kom with dia hand kon put una dotas for dia shoulder.
ISA 49:23 Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
ISA 49:24 So na who go fit seize wetin soja karry kom from war? Una fit go release doz wey strong men katch?
ISA 49:25 But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.
ISA 49:26 I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”
ISA 50:1 Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.
ISA 50:2 Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
ISA 50:3 I fit kover di sky with darkness kon make am wear sak like who dey mourn.”
ISA 50:4 God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
ISA 50:5 God don make mi undastand well-well and I neva tok anyhow or turn from am.
ISA 50:6 I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
ISA 50:7 But dia curse nor dey pain mi and bikos God wey get pawa dey help mi, I dey fit bear dem. I know sey dem nor go fit disgrace mi,
ISA 50:8 bikos God dey near and E go show sey, I dey innocent. So, e get anybody wey go fit komplain about mi? Den, make wi go kourt togeda! Make e kom tok wetin I do!
ISA 50:9 Na God wey get pawa, help mi, so who go fit sey I dey guilty? All di pipol wey dey akuiz mi go disappear, dem go vanish like klot wey dey fade.
ISA 50:10 All of una wey dey respet God and obey en savant words, di road wey una dey waka fit dey dark, but make una trust una Oga God! Make una put hope for una God.
ISA 50:11 All of una wey dey plan to distroy oda pipol, na una own plan go distroy una. God ensef go make dis tins happen and una go sofa well-well.
ISA 51:1 God sey, “Una wey wont make dem save una; una wey dey kom meet mi make I help una. Make una tink of di Rock wey una from kom, di place where dem from kut una from.
ISA 51:2 Make una tink of Abraham, una grand-grand papa and Sarah wey born una. Wen I koll Abraham, e nor get pikin, but I bless and gi-am shidren kon make en shidren-shidren, plenty.
ISA 51:3 I go sorry for Jerusalem and evribody wey dey stay di land wey dem skata. Even doh en land na desert, I go turn am to gardin and e go bi like Eden gardin. Joy and happiness go dey der and dem go sing songs take praiz and tank mi.
ISA 51:4 My pipol, make una listin to mi! Make una listin to wetin I dey tok: I dey tish di nashons and my laws go bring lite to dem.
ISA 51:5 I go kom save dem kwik-kwik, bikos my time to win, don near. Mi mysef go rule all di nashons. Di lands wey dey far dey wait make I kom; dem dey wait with hope make I kon save dem.
ISA 51:6 So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.
ISA 51:7 Pipol wey know wetin dey rite, wey put wetin I dey tish dem for dia heart, make dem listin to mi. Make dem nor fear wen pipol dey curse dem.
ISA 51:8 Dem go vanish like klot wey ant chop! But wen I diliver una, e go last forever; my viktory go last forever.”
ISA 51:9 Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
ISA 51:10 Na Yu dry di sea kon make road for inside wota, so dat di pipol wey Yu won save, go fit waka pass for dry groun.
ISA 51:11 Doz wey Yu don save go rish Jerusalem with joy, dem go dey sing and shaut with happiness. Dem go dey happy and dey free from sorrow forever.
ISA 51:12 God sey, “Na mi dey give una pawa. So why una dey fear ordinary men wey nor go last pass grass?
ISA 51:13 Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
ISA 51:14 Dem go soon free pipol wey dey for prison; dem go get long life and honga nor go kill dem.
ISA 51:15 Na mi bi di Oga wey bi una God, I dey shake di sea kon make di wave shaut. My name na God wey get pawa!
ISA 51:16 I stresh heaven kon make di eart foundashon! I tell Jerusalem, ‘Una bi my pipol! I don tish and protet una with my hand.’ ”
ISA 51:17 Jerusalem, make una wake-up! Make una karry unasef up! Una don drink from di ponishment cup wey God give una, bikos E dey vex. Una drink am and e dey make una stagga.
ISA 51:18 Nobody dey wey go lead una; nobody among una pipol go hold una for hand.
ISA 51:19 Wahala don fall for una head; war don skata una land and una pipol dey hongry. E nor get anybody wey go sorry for una.
ISA 51:20 Una shidren dey fall and faint street, bikos dem don weak; dem bi like animal wey hunta net katch. Dem don si how God vexnashon dey bi.
ISA 51:21 Jerusalem pipol wey dey sofa, una wey dey stagga like sey una don drink,
ISA 51:22 di Oga wey bi una God dey defend una naw sey, “I dey take di cup wey I give una with vexnashon. Una nor go drink di wine wey dey make una stagga again.
ISA 51:23 But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”
ISA 52:1 Jerusalem pipol, make una dey great and strong again! God holy town, make una wear pride like klot! Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
ISA 52:2 Jerusalem pipol, make una shake unasef kon dey free! Make una stand up from dirty kon sidan for una throne! Zion pipol, make una luz di shain wey tie una!
ISA 52:3 God wey get pawa dey tell en pipol sey, “Wen una bi slave, dem nor pay any money take buy una, na so too, dem nor go pay anytin to take free una.
ISA 52:4 Wen una go stay for Egypt as strenja, na una own mind una take do am; even doh, Assyria pipol use force karry una komot, dem nor still pay anytin for una head.
ISA 52:5 Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.
ISA 52:6 But di time dey kom wen una go know sey na mi bi God and I don tell una.”
ISA 52:7 Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
ISA 52:8 Pipol wey dey guide di town, dey shaut as dem dey happy, bikos dem don si sey God dey kom back to Zion.
ISA 52:9 Jerusalem wey dem skata, make una shaut dey happy, bikos God go save en pipol kon give dem peace.
ISA 52:10 God go use en holy pawa take save en pipol and di whole world go si am.
ISA 52:11 All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.
ISA 52:12 Una nor go hurry komot dis time, or try to eskape, bikos di Oga wey bi una God, go lead and protet una for evry side.
ISA 52:13 God sey, “My savant go get wetin e dey find; dem go honor am well-well.
ISA 52:14 Pipol go sopraiz wen dem si am, bikos dem bin beat am well-well and e nor bi like human being again.
ISA 52:15 But naw, many nashons go happy for am and kings nor go fit tok anytin. Dem go si and undastand di tins wey dem neva hear before.”
ISA 53:1 “Na who go bilive di message wey wi dey hear naw? Na who don si God hand for dis matter before?
ISA 53:2 My savant grow like seed wey dem plant for dry groun. E nor even get beauti or respet wey go make us notis am.
ISA 53:3 Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.
ISA 53:4 But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own. But wi tink sey en sofa na di ponishment wey God gi-am.
ISA 53:5 But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well.
ISA 53:6 All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.
ISA 53:7 Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin.
ISA 53:8 Dem arrest and sey make dem kill-am and nobody kare about am. Dem kill-am, bikos of awa sins.
ISA 53:9 Even doh e nor do any bad tin or tok lie, dem plan to put am for grave with wiked pipol but dem kon beri am for rish man grave.”
ISA 53:10 Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.
ISA 53:11 But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.
ISA 53:12 So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.
ISA 54:1 “Wimen wey neva born pikin before, naw, make una sing and shaut with happiness, bikos di shidren wey una go born, go plenty pass di ones wey di woman wey get husband, born.
ISA 54:2 Make una make una house big well-well; make en rope and en peg dey strong well-well.
ISA 54:3 Una go spread go rite and left; una shidren-shidren go kover evriwhere kon stay for town wey dem don forget before.
ISA 54:4 Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.
ISA 54:5 Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.
ISA 54:6 Israel pipol, una bi like yong wife wey sorrow full en heart, bikos en husband leave am.” But God dey koll una kom meet am sey,
ISA 54:7 “Even doh I leave una for shot time, I go take una back and show una my love wey nor dey end.
ISA 54:8 I vex leave una small, but I go show una my love forever.”
ISA 54:9 “I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.
ISA 54:10 Even doh di mountins and hills go skata, di love wey I get for una, nor go ever end. I go keep my peace and promise forever.” Na God wey love una, tok all dis tins.
ISA 54:11 God sey, “My Jerusalem; di town wey dey sofa and nor get help; di place wey nor get who go konfort am. I go use stones wey dear well-well take build una foundashon again.
ISA 54:12 I go build una towa with rubi kon use stones wey dey shine like fire take build una gates. And di wall wey surround una, na jewels I go take build am again.
ISA 54:13 Na only mi go tish una pipol and I go give dem peace kon make dem prosper.
ISA 54:14 Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.
ISA 54:15 Anybody wey attack una, do am on en own and anybody wey dey fight una, go fall.
ISA 54:16 Na mi kreate di man wey dey melt gold, make fire and form weapon and na mi still kreate di soja wey dey use di weapon kill pipol.
ISA 54:17 But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
ISA 55:1 God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!
ISA 55:2 Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.
ISA 55:3 My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
ISA 55:4 I make am leader and kommander for many nashons and I show dem my pawa thru am.
ISA 55:5 Naw, una go gada oda nashons wey una nor know before. And nashons wey nor know una before, go run kom meet una! Bikos mi wey bi di Oga una God, di Pesin wey bi Israel God wey dey holy, go make all dis tins happen. I go give una honor and glory.”
ISA 55:6 Make una turn and pray to God naw wen E dey near una.
ISA 55:7 Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
ISA 55:8 God sey, “I nor dey tink as una dey tink and una ways difren from my own.
ISA 55:9 As heaven high pass di eart, na so my ways and di way I dey tink, high pass una own.
ISA 55:10 My words bi like snow and rain wey dey kom wota di eart from di sky. Dem dey make plant grow and provide seed wey dem go chop and plant.
ISA 55:11 Na so e bi too with di word wey I dey tok; e go must do wetin I plan for am. E go must do evritin wey I send am make e kom do.
ISA 55:12 Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
ISA 55:13 Cypress trees go grow for where grass dey naw. Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey. Dis sign go dey forever and e go dey remind una about wetin mi wey bi God don do.”
ISA 56:1 God dey tell en pipol, “Make una do wetin dey good and korrect, bikos I go soon kom save una.
ISA 56:2 I go bless pipol wey always dey keep di Sabat Day and obey di kommand. I go bless doz wey nor dey do wiked tins.”
ISA 56:3 Strenjas wey dey follow una woship, make dem nor sey “God nor go ever take us as en pipol.” And man wey nor fit sleep with woman, make e nor sey, “My own don finish for dis life bikos I nor go ever fit born pikin.”
ISA 56:4 God dey tell dat kind man sey, “If yu honor and keep di Sabat Day; kon do wetin I wont and keep my kovenant,
ISA 56:5 I go remember una name for my temple and among my pipol and dat one betta pass any shidren wey una go fit get and una name go dey forever.”
ISA 56:6 God dey tell di strenjas wey join en pipol, doz wey love and dey serve am well; wey dey keep di Sabat Day and dey faithful as dem dey keep en kovenant sey:
ISA 56:7 “I go bring una kom Zion wey bi my holy hill kon give una joy wen una enter my prayer house, den I go asept di sakrifice wey una go offa for my altar. Dem go koll my temple, ‘Prayer house’, for all di nashons.”
ISA 56:8 God wey get pawa, wey bring Israel en pipol kom back from Babilon, don promise sey E go bring odas kon join dem too.
ISA 56:9 God don tell di oda nashon make dem kom like wiked animals kon skata en pipol.
ISA 56:10 E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!
ISA 56:11 Dem bi like wiked dogs wey nor-tin dey satisfy. Dis leaders nor dey undastand at-all. All of dem dey do as dem like.
ISA 56:12 Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”
ISA 57:1 Raitious pipol dey die and nobody undastand or even kare. Betta men dey die, yet nobody dey si di evil wey dey kom.
ISA 57:2 Pipol wey dey live betta life, get peace and dem dey rest even wen dem don die.
ISA 57:3 But una wey bi sinnas! Make una kom here make dem judge una! Na pipol wey dey do majik and ashawo born una.
ISA 57:4 Who una dey fool? Who una dey laf and lie give?
ISA 57:5 Una dey woship yeye gods and dey sleep with each oda under doz trees. Una dey sakrifice una shidren for di rock wey dey near di stream.
ISA 57:6 Una take smooth stones from der kon dey woship am as god. Una pour wine put kon give dem rice as ofrin. So, una tink sey I dey happy with all dis tins wey una dey do?
ISA 57:7 Una dey go di mountins wey high pass go sakrifice and sleep with one anoda.
ISA 57:8 Una put una juju for una door-mot and una nor dey respet Mi wey bi God! Una pul una klot, klimb bed with una love wey una give money make dem for sleep with una. Den una kon satisfy unasef.
ISA 57:9 Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.
ISA 57:10 Naw, make una si as una dey work hard to find oda gods and yet e nor dey taya una. Una tink sey na bikos una juju dey give una pawa, na-im make una nor dey taya to work?
ISA 57:11 God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?
ISA 57:12 Una tink sey wetin una dey do dey rite, but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.
ISA 57:13 Wen una kry for help, make una juju kom save una. Na one small breeze go karry dem go! But pipol wey trust mi go stay di land kon woship mi for my temple forever.”
ISA 57:14 God sey, “Klear di road! Klear di road! Make una remove di tins wey fit stop my pipol to turn back kom meet mi!
ISA 57:15 Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
ISA 57:16 I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.
ISA 57:17 I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.
ISA 57:18 I don si how dem dey bihave, but I go heal dem. I go lead and help dem and I go konfort doz wey dey mourn.
ISA 57:19 I go give peace to evribody, both doz wey dey far and near! I go heal my pipol.
ISA 57:20 But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.
ISA 57:21 Wiked pipol nor go ever get peace of mind.”
ISA 58:1 God sey, “Make una shaut well-well! Make una tell Israel wey bi my pipol about dia sins!
ISA 58:2 Dem dey woship mi evriday dey sey, dem won know my ways and obey my laws. Dem sey make I just dey give dem my laws, bikos dem dey happy to woship mi.”
ISA 58:3 Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.
ISA 58:4 Una fasting dey make una wiked and una still dey kworel and fight. Una tink sey dis kind fasting go make mi listin to una prayers?
ISA 58:5 Na di kind fasting wey I choose bi dis? Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol? Na just to skrape di hair for una head rish groun, I wont? Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes? Na dis one una dey koll fasting, di day wey God wont?
ISA 58:6 Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.
ISA 58:7 Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.
ISA 58:8 Den my favor go shine for una body like morning sun and una sore go kwik heal. I go always dey to save una and my present go protet una for evriwhere.’
ISA 58:9 Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;
ISA 58:10 if una give food to pipol wey dey hongry kon satisfy doz wey nor get, di darkness wey dey round una, go brite like aftanoon sun.
ISA 58:11 Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
ISA 58:12 Una pipol go build wetin don skata since, dem go build am put for di old foundashon again. Dem go know una as pipol wey ribuild di wall and house wey dem bin skata.”
ISA 58:13 God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,
ISA 58:14 den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.”
ISA 59:1 Make una nor tink sey God dey too weak to save una or dey deaf to hear wen una koll am for help!
ISA 59:2 Na bikos of una sins make am nor dey hear una. Na una sins dey separate una from God wen una try to woship am.
ISA 59:3 All una words na lie and pipol wey una kill, dia blood don stain una hand.
ISA 59:4 Una dey go kourt and dey lie for each oda head. Una dey put hope for lie, so dat una go win una kase. Una dey make plans to take hurt oda pipol.
ISA 59:5 Di evil wey una dey do dey bad like di poizin wey dey snake wey dem just born.
ISA 59:6 But di evil nor go do una any good; dem dey yuzles like klot wey dem make with dirty!
ISA 59:7 Na only evil tins una dey plan to do. Una nor dey fear to kill innocent pipol. Anywhere wey una dey go, na only wahala una dey kause for der
ISA 59:8 and nobody dey save around una. Evritin wey una dey do nor get betta judgement. Una dey follow di wrong road. And nobody wey dey pass dat road, dey save.
ISA 59:9 Di pipol sey, “Na naw wi know why God nor save us from doz wey dey opress us. Wi dey hope sey wi go si lite, but na only darkness wi dey si
ISA 59:10 and wi dey waka anyhow like blind pipol. Wi dey fall for aftanoon and for nite; e bi like sey wi dey dark world, for where dead pipol dey.
ISA 59:11 Dem dey sofa and make us fear. Wi won si God, so dat E go save us from di opreshon and bad tins wey wi dey do, but e nor gri work.
ISA 59:12 Oga God, di bad tins wey wi do against Yu, plenty well-well. Awa sins dey fight us and wi know sey na so e bi.
ISA 59:13 Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu. Wi opress odas kon turn from Yu. All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.
ISA 59:14 Betta judgement dey far from us and good tins nor fit kom near us. Trut nor dey for where pipol gada and nobody dey good.
ISA 59:15 Trut nor dey awa mout again and di pesin wey nor dey won do evil, dem dey take en tins from am. God dey look and vex, bikos betta judgement nor dey una body.”
ISA 59:16 E dey sopraiz am sey, nobody dey to help pipol wey dem dey opress. So E go save dem with en own pawa kon make dem get viktory.
ISA 59:17 E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.
ISA 59:18 E go ponish en enemies akordin to wetin dem do; even doh dem dey stay for far place.
ISA 59:19 From east go rish west, evribody go fear en and en great pawa. E go kom like river wey dey rush well-well and like strong breeze wey dey blow.
ISA 59:20 God dey tell en pipol sey, “I go kom Jerusalem kon defend and save all of una wey turn from una sin kom meet mi.
ISA 59:21 I make kovenant with una sey: I don give una my pawa and word forever and from naw go, make una dey obey mi kon tish una shidren and shidren-shidren, so dat dem go obey mi forever.”
ISA 60:1 Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun, bikos God glory dey shine on-top una!
ISA 60:2 Even wen darkness kover evry oda nashon, God lite go shine on una own and en present wey brite well-well, go dey with una.
ISA 60:3 Nashons go kom enter una lite and kings go enter una brite lite.
ISA 60:4 Make una look round kon si wetin dey happen; una pipol dey gada kom house! Una shidren go kom from far place; dem go karry una girls for shoulder kom back.
ISA 60:5 Una go si dis tins kon happy; una go dey happy as una dey waka. Dem go bring all di nashons propaty kom give una. Dem go bring dia money from di oda side of di river kom.
ISA 60:6 Plenty karavan with kamels go kom una land from Midian and Efah town. Dem go kom give una gold and incense from Sheba town. Pipol go tok about di good tins wey God don do for una!
ISA 60:7 Dem go bring all Kedar and Nebaiot sheep kon give una as sakrifice and dem go offa dem for di altar to take make belle sweet God. God temple go get glory pass as e get before.
ISA 60:8 So, wetin bi all dis sheep wey dey pass like kloud; like doves wey dey go house?
ISA 60:9 Di ship dem dey kom from far; dem dey karry God pipol with silva and gold kom back to dia house and to take honor God name, di Oga wey bi Israel pipol God wey dey holy and all di nashon dey honor en pipol.
ISA 60:10 God tell Jerusalem pipol, “Oda pipol go build una wall and dia kings go serve una. I bin ponish una, bikos I dey vex, but naw, I go show una my favor and mesi.
ISA 60:11 Una gates go dey open both for day and nite, so dat kings go bring dia propaty kon give una.
ISA 60:12 But dem go distroy any nashon wey nor gri serve una.
ISA 60:13 Dem go bring pine wood, junipa, cypress and di wood wey fine pass for Lebanon forest kom take build Jerusalem again; so dat my temple go fine and di town go get glory.
ISA 60:14 Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
ISA 60:15 Dem nor go hate and look down on una again. Una town wey dem skata and distroy, I go make am great and beautiful and joy go dey der forever and ever.
ISA 60:16 Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.
ISA 60:17 Instead of bronze, I go give una gold. I go give una silva and bronze, instead of iron and wood; den I go still give una iron, instead of stone. Una rulers nor go opress una again and I go make dem rule with betta judgement and peace.
ISA 60:18 Dem nor go hear wahala sound again for dis town; distroshon nor go skata una kountry again. I go protet and defend una like wall; den una go praiz mi, bikos I don save una.
ISA 60:19 Di sun nor go bi una lite for day time again or di moon for nite, bikos na mi, wey bi God, go bi una lite forever and my glory lite go always dey shine on una.
ISA 60:20 Una days of pains don end. Mi wey bi God go bi una lite forever and e go last pass di sun and moon.
ISA 60:21 Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish.
ISA 60:22 Even una small family wey dey honbol demsef, go dey great like nashon wey get pawa well-well. Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik. Na mi wey bi God, tok am!”
ISA 61:1 God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
ISA 61:2 E send mi kom tell pipol sey di time for God to save en pipol and defeat dia enemies, don rish! Yes, E go konfort doz wey dey mourn.
ISA 61:3 E sey, instead of sadnes, E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion. Instead of sorrow, E go put praiz song for dia mout. Dem go bi like tree wey God plant by ensef. All of dem go do wetin dey rite and dem go praiz God for wetin E don do.
ISA 61:4 Dem go ribuild di towns wey skata kon ripair di place dem wey pipol distroy.
ISA 61:5 My pipol, strenjas go serve una. Dem go kare for una animals; farm for una land and kare for una vineyards.
ISA 61:6 Dem go know una as God priests wey bi en savant. Una go enjoy di nashon propaty. Den una go dey proud sey na una own.
ISA 61:7 Una shame and disgrace don end. Una go stay for una own land and una propaty go bi times two, den una joy go last forever.
ISA 61:8 God sey, “I like betta judgement, but I hate opreshon and wahala. I go dey faithful to reward my pipol and make kovenant wey go last with dem.
ISA 61:9 Dem go know dem for all di nashons and anybody wey si dem, go know sey dis na pipol wey I bless.”
ISA 61:10 Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
ISA 61:11 Just as seed dey take grow, na so God wey bi king, go take save en pipol and all di nashons go praiz am.
ISA 62:1 I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.
ISA 62:2 Jerusalem pipol! Nashons go si una viktory! Dia kings go si una glory. Dem go koll una with di new name wey God ensef give una.
ISA 62:3 For God hand, una go bi like crown wey get glory! Yes, una go bi like royal crown for God hand.
ISA 62:4 Dem nor go koll una “Pipol wey dem rijet again” or koll una land, “Di wife wey en husband drive komot house.” But dis na di new name wey dem go koll una, “God dey happy with una.” Dem go tell una land sey: “Yu marry well.” Dis na bikos God dey happy with una and E go bi like husband to una.
ISA 62:5 Like yong man wey marry virgin, na so too en wey form una, go marry una. As husband dey happy with en wife, na so una God go dey happy with una too.
ISA 62:6 Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.
ISA 62:7 Make una nor let am rest till E build Jerusalem again kon turn am to town wey di whole world go dey praiz.
ISA 62:8 God don make betta promise and E go make am happen with en pawa den E go sey: “Enemies nor go chop una korn again and strenjas nor go drink una wine again.
ISA 62:9 But una wey plant and harvest di korn, go chop di bread kon praiz God. Una wey gada di grapes, go drink di wine for my temple yard.”
ISA 62:10 Jerusalem pipol, make una go outside di town go build road for una pipol wey dey kom back! Make una do betta road kon remove all di stones for der! Make una put one sign, so dat all di nashons go know
ISA 62:11 sey, God dey announce give di whole world naw sey: “Make una tell Jerusalem pipol sey God dey kom save dem and E dey kom with doz wey E don already save.”
ISA 62:12 Dem go koll una, “God holy pipol; di ones wey God save.” Dem go koll Jerusalem, “Di town wey God love and where E go stay forever.”
ISA 63:1 “Who bi dis pesin wey dey kom from Bozrah wey dey Edom? Who wear fine red klot dey waka kom with pawa and strent?” Na mi God wey dey speak with raitiousness, wey dey mighty and get pawa to save.
ISA 63:2 “Why en klot red like dat? Why e red like man wey dey mash grapes to take make wine?”
ISA 63:3 God ansa, “I mash di nashons like grapes by mysef. I use my vexnashon mash dem and na dia blood stain my klot so.
ISA 63:4 I just feel sey di time to save my pipol don rish and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.
ISA 63:5 I sopraiz wen I si sey nobody dey to help doz wey dem dey opress. So, mi mysef kon go save and diliver dem with my strong hand.
ISA 63:6 I mash di nashons as I dey vex kon skata dem. Den I pour dia blood for groun.”
ISA 63:7 I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.
ISA 63:8 God sey, “Dem bi my pipol and dem nor go lie give mi.” E save dem
ISA 63:9 from all dia sofa. Nor bi angel save dem, but na God save dem by ensef. E use en love and mesi take save dem. E dey kare for dem since,
ISA 63:10 but dem fight against am kon make am vex. So God kon bi dia enemy and E fight against dem too.
ISA 63:11 Den di pipol remember as e bi before; dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask, “Where di God wey save en pipol from di sea? Where di God wey give Moses en Spirit?
ISA 63:12 Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea kon lead en pipol pass di deep wota, so dat honor and glory wey nor dey end, go bi en own?”
ISA 63:13 Dia leg strong for groun like horse wey dey run fast and dem nor fall, bikos God dey lead dem.
ISA 63:14 Just as dem dey lead melu go valley wey get betta grass, na so too God dey give en pipol rest. E lead en pipol kon bring honor to en name.
ISA 63:15 Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.
ISA 63:16 Na Yu bi awa papa. Even if Jakob and Abraham wey bi awa grand-grand papa sey dem nor know us, Yu God na awa papa and na Yu dey always save us.
ISA 63:17 Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.
ISA 63:18 Na small time wi spend for yor house before awa enemies drive us kon skata yor temple.
ISA 63:19 Wi bi yor own from biginnin; but Yu neva rule dem before and nobody don ever koll dem with yor name.
ISA 64:1 How I wish Yu go tear di sky open kon kom down from heaven! Di mountins go si Yu kon shake with fear.
ISA 64:2 Dem go dey shake like wota wey dey boil for hot fire. Make Yu kom show yor pawa to yor enemies, so dat di nashons go fear wen dem si Yu,
ISA 64:3 bikos wen Yu do tins wey wi nor espect; wen Yu kom down, di pipol kon dey fear. Wen di mountins si Yu, dem bigin shake dey fear.
ISA 64:4 Nobody don si or hear about any oda god wey bi like Yu or di one wey fit do di kind tins wey Yu dey do for doz wey put dia hope on Yu.
ISA 64:5 Yu dey help pipol wey dey do wetin dey rite; pipol wey remember how Yu wont make dem dey live dia life. But wen wi kontinue to dey kommit sin, Yu vex for us. So na how wi wont make Yu take save us?
ISA 64:6 All of us nor dey klean and dirty full awa life. Bikos of awa sins, wi bi like leaf wey don fade wey breeze dey blow trowey.
ISA 64:7 Nobody dey pray to Yu again; nobody dey kom meet Yu for help again. Yu don hide yorsef and abandon us, bikos of awa sins.
ISA 64:8 But Oga God, na Yu bi awa papa. Wi bi klay and na Yu mold us. Na Yu kreate us,
ISA 64:9 so make Yu nor too vex for us or use awa sins against us forever. Wi bi yor pipol, so make Yu sorry for us.
ISA 64:10 Yor holy towns bi like desert na; Jerusalem na desert wey don skata
ISA 64:11 and awa temple wey holy and fine, wey awa grand-grand papa dem for dey praiz Yu before, don skata and dem distroy am with fire. Evriwhere wey wi love, don skata.
ISA 64:12 So Oga God, all dis tins nor koncern Yu at-all? Yu nor won do anytin? Yu won make wi sofa pass as wi fit bear?
ISA 65:1 God sey, “I bin dey ready to help my pipol, but dem nor kom meet mi make I help dem. I bin dey ready make dem look for mi, but dem nor even try. All di nashons nor pray to mi, even doh I dey ready to ansa sey: ‘Na mi bi dis, I go help una.’
ISA 65:2 I always dey ready to welkom my pipol wey dey sturbon, dey do wrong and dey go dia own way.
ISA 65:3 Dem dey always make mi vex, as dem dey offa juju sakrifice inside di holy gardin kon burn incense for di stone altars.
ISA 65:4 Dem dey go grave for nite go beg dead body spirit make e help dem. Dem dey chop pig and drink wetin kom out from di meat wey dem sakrifice give juju.”
ISA 65:5 Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.
ISA 65:6 I don already know how I go take ponish dem and dem don rite di way dem go take die for groun. I nor go look wetin dem don do kon trowey face, but I go pay dem back
ISA 65:7 for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”
ISA 65:8 God still sey, “Nobody dey distroy good grapes, instead, dem go use dem make wine. And na so too I nor go distroy all my pipol, but I go save doz wey dey serve mi.
ISA 65:9 I go bless Israel pipol wey kom from Judah tribe and na dia shidren-shidren go stay my land. My pipol wey I choose wey serve mi, na dem go stay for der.
ISA 65:10 Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon and for Akor Valley for east.
ISA 65:11 But una wey nor dey obey mi; wey don forget my holy mountin. Wey prepare tabol for Gad wey bi Babilon god kon mix drink for dat god wey dem dey kol Destiny, wey dey give hope and luck to pipol,
ISA 65:12 una go die yeye deat, bikos na so una wont am and una nor ansa wen I koll una or listin wen I tok to una. Una nor gri obey mi, instead una kon dey do wiked tins.
ISA 65:13 I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.
ISA 65:14 My pipol go sing dey happy, but doz wey nor dey obey mi, go kry with pain.
ISA 65:15 Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.
ISA 65:16 Anybody for di land wey ask for blessing, God wey dey faithful go bless am. Anybody wey won swear, go use God name wey bi trut take swear and dis na bikos di trobol wey dey before, don pass and I go forget dem forever.”
ISA 65:17 God sey, “I go kreate new heavens and new eart. Nobody go remember di tins wey don happen before and e go komot from dia mind kpata-kpata.
ISA 65:18 But make una dey happy forever, bikos of wetin I go kreate. Di new Jerusalem wey I go make, na only joy go full am and en pipol go dey happy.
ISA 65:19 Joy go full my heart, bikos of Jerusalem and en pipol. Pipol nor go kry or feel pain for der again.
ISA 65:20 Small shidren nor go die again and evribody go get long life. Even wen pesin don rish hundred years, dem go sey e still dey yong. If dem die before dat time, e go bi sign sey, I ponish dem.
ISA 65:21 My pipol go build house kon stay inside. Dem go plant vine kon enjoy di fruit and di wine.
ISA 65:22 Anoda pesin nor go stay inside di house wey dem build and odas wey nor plant, nor go drink di wine wey my pipol make, bikos my pipol go get long life like tree and dem go enjoy evritin wey dem work for.
ISA 65:23 Dem go susid for di work wey dem dey do and dia shidren nor go sofa. I go bless dem and dia shidren-shidren forever.
ISA 65:24 Even before dem go pray to mi, I go ansa dia prayers and as dem still dey tok, I go hear dem.
ISA 65:25 Wolf and sheep go dey chop togeda; lions go chop grass like melu, while snake go chop san and dem nor go dey wiked again. Nor-tin wey go kause wahala or evil go dey for my holy mountin for Zion again.”
ISA 66:1 God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?
ISA 66:2 Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
ISA 66:3 Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.
ISA 66:4 So, I go bring wahala and di tins wey dem dey fear, bikos wen I koll, nobody ansa and wen I dey tok to dem, nobody gri listin to mi. Evritin wey dem do dey make mi vex and dia ways nor bi my ways.”
ISA 66:5 Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.
ISA 66:6 “Make una listin to dat loud nois for di town; dat sound for di temple na di sound wey God take dey ponish en enemies!
ISA 66:7 My holy town bi like woman wey just born pikin without sey e labor. E born boy pikin without pain.
ISA 66:8 E get anybody wey don hear or si dat kind tin before? E don get any town wey dem use one day make? So, Zion nor go sofa tey again, before I go bring am kom back to life.
ISA 66:9 Make una know sey I go kare for my pipol until dem go born. Yes! I go kare for dem until dem born di pikin.”
ISA 66:10 “So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!
ISA 66:11 Una go enjoy en propaty like pikin wey dey suck en mama breast. Una go drink beleful bikos of all di tins wey e get.”
ISA 66:12 God sey, “I go make una prosper forever; all di nashon propaty go kom meet una like river wey nor dey dry. Una go bi like pikin wey en mama kare and karry for hand kon trit am with love.
ISA 66:13 Just as mama dey konfort and kare for en pikin, na so too I go konfort and kare for Jerusalem pipol.
ISA 66:14 Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”
ISA 66:15 God go kom with fire. E go ride kom with di kloud kon ponish doz wey E dey vex for.
ISA 66:16 Wiked and bad pipol wey dey di world, E go ponish dem with fire and swod kon kill dem well-well.
ISA 66:17 God sey, “Di end don rish for doz wey dey keep diasef holy bikos of dia juju; doz wey dey go woship for juju gardin; wey dey chop pig and rat with oda yeye food.
ISA 66:18 I know wetin dey dia mind and wetin dem dey do. I dey kom gada all di nashon togeda and wen dem don kom togeda, dem go si wetin my pawa fit do
ISA 66:19 and dem go know sey na mi ponish dem. “But I go send some of dem go far nashon wey neva hear how I dey great rish or si di great tins wey I dey do. Na with my pawa, I go take send dem go Spain, Libya and Lydia with dia strong men. I go send dem go Tubal and Greece and na dem go tell doz nashons how I great rish.
ISA 66:20 Just as Israel pipol dey bring rice ofrin kom di temple with fine kontaina, na so too dem go bring all una men from all di nashons kom give mi as ofrin for my holy mountin. Dem go karry dem kom my holy hill for Jerusalem with horse, melu, kamel, shariot and truck.
ISA 66:21 I go make some of dem priest and some go bi Levi wey dey work for God temple.”
ISA 66:22 God sey, “Just as di new eart and heaven wey I go make go dey with mi forever, na so too una name and una shidren-shidren name go dey with mi forever.
ISA 66:23 For evry New Moon festival and Sabat Day, evribody go kom Jerusalem kon woship mi.
ISA 66:24 All doz wey bin fight mi, dem go si dia dead body for road. Di worms wey chop dem nor go ever die and dem nor go ever kwensh di fire wey go burn dem. Dia dead body nor go dey good for human being to si.”
JER 1:1 Jeremaya wey bi Hilkaya pikin, na wetin e profesai, dey dis book. Jeremaya na one among di priests wey dey stay Anatot for Benjamin aria.
JER 1:2 God first tok to Jeremaya for di thirtint year wen Amon pikin, Josaya dey rule Judah.
JER 1:3 God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
JER 1:4 God tell mi sey,
JER 1:5 “Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”
JER 1:6 So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”
JER 1:7 But God sey, “Make yu nor sey, ‘I still yong.’ But yu go-go meet anybody wey I send yu go meet kon tell dem evritin wey I kommand yu.
JER 1:8 Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”
JER 1:9 So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
JER 1:10 So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”
JER 1:11 Afta, God koll and ask mi: “Jeremaya! Wetin yu dey si?” I ansa, “Na one almond tree branch.”
JER 1:12 Den God sey, “Yu dey rite and dis mean sey, I dey look well to make sure sey evritin go happen, just as I tok am.”
JER 1:13 God ask mi again, “Na wetin yu dey si?” I ansa, “I si pot wey wota full dey boil for di nort side and e dey kom meet us.”
JER 1:14 So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.
JER 1:15 All di sojas for nort, I go soon koll dem kom attack Jerusalem. Dia kings go build dia throne for Jerusalem gate kon distroy all di walls wey dey guide di town. Den dem go attack all di towns for Judah.
JER 1:16 Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.
JER 1:17 “But yu, Jeremaya! Make yu ready go tell dem evritin wey I kommand yu. Nor fear dem, if not, I go give yu betta rizin to fear dem.
JER 1:18 Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
JER 1:19 Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu.
JER 2:1 God kon tell mi sey,
JER 2:2 “Go tell evribody for Jerusalem sey: ‘God sey, “I remember as una dey faithful wen una dey yong. Una bin love mi well-well like woman wey just marry; una follow mi waka for wildaness and for dry land.
JER 2:3 Dat time, Israel pipol dey holy to di Oga God; na dem bi di first fruit wey E plok and evribody wey won attack Israel, God dey ponish and distroy dem.” ’ ”
JER 2:4 Naw, Jakob shidren-shidren and Israel family, make una listin to God word.
JER 2:5 God sey, “Wetin una grand-grand papa dem sey I do wey make dem waka leave mi? Dem go woship yuzles juju and e kon make dem dey yuzles too.
JER 2:6 Dem nor even ask sey, ‘Where God wey take us komot from Egypt? Di Pesin wey take us pass wildaness and desert, land wey nor good and dey dry, where pipol nor dey stay or travel pass.’
JER 2:7 I take una go betta land, so dat una go enjoy di fruit and all di oda good tins wey dey der, but wen una rish der, una turn di land to dirty.
JER 2:8 Una priests nor even ask sey, ‘Where Oga God dey?’ Doz wey dey tish my law nor even know mi. Una rulers don turn from mi. Una profets dey profesai with Baal name and una leaders dey woship juju wey nor fit help or save dem.
JER 2:9 “Bikos of dis, mi God go tell una wetin I get against una and una shidren-shidren.
JER 2:10 Make una go shek thru Cyprus land for west or Kedar land for east, una go si sey dis kind tin neva happen before.
JER 2:11 No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.
JER 2:12 So heavens, make una sopraiz bikos of dis tins. Yes! Make una shok and sopraiz well-well,
JER 2:13 bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.
JER 2:14 “Israel pipol, dem nor born una as slave; na for war dem for katch and karry una go as slave.
JER 2:15 Di enemies dey shaut like lion as dem dey distroy my pipol; skata dia land and burn di towns with doz wey dey stay der.
JER 2:16 Yes! Memfis and Egypt sojas don distroy Israel glory and dem nor dey fear mi again.
JER 2:17 But na Israel pipol kause all dis tins, bikos dem leave di Oga wey bi dia God, even wen E dey show dem di korrect road.
JER 2:18 Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?
JER 2:19 Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.”
JER 2:20 “E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.
JER 2:21 I bin plant una like special vine wey dem make with di best tins. So na how una kon take turn wiked vine, wey dey produce bad grape?
JER 2:22 No amount of soap wey una go take wosh una sin, go fit make una klean, bikos I still dey si all di wiked tins wey una dey do.”
JER 2:23 How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.
JER 2:24 Una bi like wiked woman donkey wey grow for desert and bikos e dey find man, e go dey use en nose smell evriwhere weda e go si any one. Nobody fit hold am if e nid to sleep with man. Man donkey nor nid to go find am, bikos na en dey run follow dem.
JER 2:25 Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”
JER 2:26 So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.
JER 2:27 Una wey sey na tree bi una papa and rock na una mama, God go disgrace una. Dis tins go happen, bikos instead of una to follow mi, una kon waka leave mi. But anytime una dey for trobol, una go sey make I kom save una.
JER 2:28 Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.
JER 2:29 So wetin make una dey komplain? All of una don sin against mi!”
JER 2:30 “Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”
JER 2:31 Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
JER 2:32 Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.
JER 2:33 Una really know how to run follow di pesin wey una love and bikos of dis, even ashawo, don learn join en work, bikos of wetin una dey do!
JER 2:34 Poor and innocent pipol blood don stain una klot, even doh una nor katch dem dey tif for una house. Yet, with all dis tins wey una don do,
JER 2:35 una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’
JER 2:36 Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.
JER 2:37 Una go kover una face with shame and sorrow wen una dey kom back from Egypt, bikos God don rijet di pipol wey una trust and even with dia help, e nor go still betta for una.”
JER 3:1 God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.
JER 3:2 Make una look on-top di hills and una go si sey e nor get anywhere wey una neva do ashawo! Una sidan for road dey wait men, just as Arab pipol dey wait for dia enemies for desert. And naw, una don spoil di land with una ashawo and wiked life.
JER 3:3 Bikos of dis, God nor allow rain fall, even for di rite time. With all dis tins, una still dey live una ashawo life and shame nor dey katch una.
JER 3:4 Una even dey kry to mi naw sey, ‘Yu bi awa papa. Na from small pikin Yu love us kom rish naw.
JER 3:5 Yu go vex and forget us forever?’ All dis na wetin una dey tok, but una still dey do di bad-bad tins wey dey una mind.”
JER 3:6 Wen King Josaya dey rule for Judah, God tell mi sey, “Israel pipol wey nor dey faithful, yu si all wetin dem dey do? Dem don waka leave mi kon dey do ashawo for under evry green tree and high hill.
JER 3:7 I tink sey afta dem do all dis tins finish, dem go kom back kom meet mi, but dem nor kom and dia sista Judah, wey nor dey faithful too, si wetin dem do.
JER 3:8 I drive Israel pipol, bikos of dia ashawo life, yet en sista, Judah, nor fear, but e kon join dey do ashawo too.
JER 3:9 Bikos Israel sin nor mean anytin to dem, dem kon kontinue to spoil di land as dem dey woship stones and wood.
JER 3:10 Even with all dis tins, Israel sista wey bi Judah nor gri turn kom meet mi with all dia heart, but dem just dey pritend.”
JER 3:11 Den God tell mi, “Even doh Israel pipol don turn from Mi, dem still betta pass Judah wey nor dey faithful at-all.”
JER 3:12 God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.
JER 3:13 But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.”
JER 3:14 “Pipol wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi, bikos na mi get una. Among una, I go choose one pesin from each town and two pesin from each family, den bring una kom back to Mount Zion.
JER 3:15 I go give una kings wey go obey mi and dem go rule una with wisdom and undastandin.
JER 3:16 For dat time, una go plenty well-well for di land and pipol nor go sey dem wont Oga God Kovenant Box. Dem nor go even tink or remember am again: dem nor go miss am, tok-less of to make anoda one.
JER 3:17 Wen dat time rish, pipol go know Jerusalem as ‘God Throne’ and all di nashons go gada kom woship mi for der. Dem nor go do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do again.
JER 3:18 For dat time, Israel pipol go join Judah pipol kom back from di land wey dey nort and dem go kom back to di land wey I give dia grand-grand papa as dia own propaty.”
JER 3:19 God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
JER 3:20 But Israel pipol, just like woman wey nor dey faithful to en husband, na so too, una nor dey faithful to mi.”
JER 3:21 “I dey hear one nois on-top di hill: Na Israel pipol dey kry and beg dia juju. True-true, dem dey stay inside sin and don forget di Oga wey bi dia God.
JER 3:22 Naw, una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi and I go heal una!” “Yes! Wi go kom meet Yu, bikos na Yu bi di Oga wey bi awa God.
JER 3:23 True-true, hills and mountins nor fit help us. But na only Yu wey bi awa Oga God, go fit help wi, yor pipol.
JER 3:24 But all dis yeye gods don skata all di tins wey awa papa-papa dem do down; dem don kill dia animals, sons and dia dotas.
JER 3:25 So make wi liedan with shame! Make awa disgrace kover us. Wi and awa grand-grand papa don sin against di Oga awa God. Since wi dey yong kon rish naw, wi nor gri obey di Oga awa God.”
JER 4:1 God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,
JER 4:2 den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
JER 4:3 God tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una too sturbon! Una heart too hard like strong groun wey shuku-shuku full, wey farmer neva dig.
JER 4:4 Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
JER 4:5 God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.
JER 4:6 Show dem where dem go pass run go Zion. Make dem run kwik-kwik, so dat dem go dey save! Bikos God dey bring wahala kom from nort and E go distroy well-well.
JER 4:7 Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”
JER 4:8 So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.
JER 4:9 God sey, “For dat day, di mind wey kings get, go fail dem! Priests and profets go dey shek with fear.”
JER 4:10 Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.
JER 4:11 “For dat time, dem go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “ ‘I dey kommand one strong breeze kom from di desert kom meet my pipol. Di breeze nor bi to blow well or to klean my pipol,
JER 4:12 and dis breeze go strong well-well! Bikos na only God dey judge en pipol.’
JER 4:13 Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
JER 4:14 “So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
JER 4:15 From Dan town, one vois dey shaut dey kom and e dey bring bad news kom from Efraim hill.
JER 4:16 E don kom warn di nashons and tell Jerusalem pipol sey, ‘Wiked sojas dey kom from one far kountry kon tok against Judah town.’
JER 4:17 Just as pipol dey guide farm, na so di wiked men go surround Jerusalem, bikos en pipol tok against Mi.”
JER 4:18 Judah, na una kause dis wahala, bikos una dey live yeye life kon dey do bad tins. Na una sin kause dis sofa and e go pain una enter una heart.
JER 4:19 Den I sey, “I nor go fit bear dis pain! My heart dey beat fast-fast! I nor fit kwayet, bikos I hear di trumpets and war nois.
JER 4:20 I hear as wahala dey happen for evriwhere! Di whole land don skata finish. Yes! Na wons dem distroy awa tent kon tear awa curtains to pieces.
JER 4:21 Na how long I go dey si awa enemies war flag and hear dia trumpet sound?”
JER 4:22 But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
JER 4:23 I look di eart kon si sey e empty and nor get shape; I look di sky and dia lite kon vanish.
JER 4:24 As I look di mountins, dem dey shake like man wey dey fear and all di hills dey go back and front.
JER 4:25 I look kon si sey nobody dey der and di birds for di sky don fly komot.
JER 4:26 Di land wey dey fruitful before, don empty and evribody dey sofa, bikos of God vexnashon wey dey burn like fire.
JER 4:27 God sey, “Di whole land go turn desert and I go distroy am finish.
JER 4:28 Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”
JER 4:29 Evribody for di land go run wen dem hear di shariot sound kon si sojas with dia bow and arrow. Some go run go hide for forest; odas go klimb mountin go hide for rocks. Di towns go empty and nobody go remain for der again.
JER 4:30 Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.
JER 4:31 I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
JER 5:1 God sey, “Waka round Jerusalem street kon shek for where pipol gada weda una go si any good and raitious pesin. If una si, I nor go ponish di town again.
JER 5:2 Doh dis pipol dey swear with God name, but di trut bi sey, dem nor mean wetin dem dey tok.”
JER 5:3 My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
JER 5:4 So I kon sey, “Na only poor and foolish pipol dey bihave like dis. Dem dey bihave like fools, bikos dem nor know wetin God wont. Dem nor know wetin dia God wont make dem do.
JER 5:5 I go-go meet and tok to di leaders, bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.” But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.
JER 5:6 So just as lion dey attack oda animals for bush, na so too dia enemies go attack dem and just as wolf bi for desert, na so too dem go distroy dem. Na leopard go dey guide di town and if anybody won kom out from di town, dem go distroy am, bikos dia sin too many and dem don turn from God.
JER 5:7 God ask, “Jerusalem pipol! Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey, una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all? Even doh I dey give una evritin wey una wont, una still dey bihave like wife wey go sleep with who nor bi en husband and una dey stay with ashawo.
JER 5:8 Una bi like horse wey dem feed well wey still get long-trot; each of una still dey find una neighbour wife wey una go sleep with.
JER 5:9 Naw, God sey, ‘I go really ponish dem for evritin wey dem do. Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!’ ”
JER 5:10 So God kommand di enemies sey, “Make una go distroy di vines for Israel and di vineyard for Judah, but nor distroy dem finish. Kut dia branches komot, bikos doz branches nor bi God own.
JER 5:11 Dis na bikos, Israel and Judah pipol nor dey faithful to mi again.”
JER 5:12 Dem deny wetin God tok kon sey, “God nor go do anytin! No bad tin go fit happen to us; wi nor go ever si war or honga till wi die.
JER 5:13 All wetin di profets tok nor mean anytin. God nor tok thru dem, so make wetin dem tok, happen to dem.”
JER 5:14 But Oga God wey dey rule all of us kon tell mi, “Bikos dis pipol tok like dis, I go make yor words bi like fire. Den, I go make dis pipol bi like wood and di fire go burn dem.”
JER 5:15 God sey, “Israel pipol, make una listin! I dey bring enemies kom from far kountry kon attack una. Na kountry wey strong well-well; wey I kreate since; kountry wey una nor know or undastand dia language.
JER 5:16 Dia sojas get pawa well-well and dem nor dey sorry for pesin wen dem won kill-am.
JER 5:17 Dem go chop evritin wey una plant and una animals too; dem nor go leave one fruit for una vine tree. Even doh una tink sey una dey save inside una strong town, dem go distroy di town kon kill una shidren.
JER 5:18 But I nor go distroy una finish.”
JER 5:19 So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”
JER 5:20 God sey, “Go tell Jakob shidren-shidren and all Judah pipol sey:
JER 5:21 Make una listin, ‘Una bi fool and una nor get sense. Una get eye, but una nor dey si; una get ear, but una nor dey hear.’ ”
JER 5:22 God sey, “Una nor suppose fear mi wey bi God? Why una nor dey shake with fear wen una si mi? Na mi make san as boundary for sea and dis san nor go let di sea flow pass where I sey make e flow rish. Di wave fit karry di sea up-and-down, but e nor go fit pass der. Di wave fit make nois, but dem nor go fit pass di boundary.
JER 5:23 But dis pipol sturbon and get strong heart. Dem don leave mi go dia own way.
JER 5:24 Dem neva even tell diasef wons sey, ‘Make wi try fear di Oga wey bi awa God. Bikos na-im dey send rain kom for harvest time.’
JER 5:25 But, una sin don make mi stop to dey give una all dis good tins.
JER 5:26 Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.
JER 5:27 Just as hunta pak bird full kage, na so dem pak money wey dem get thru wayo full dia house and na dis make dem rish well-well kon get pawa.
JER 5:28 Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.
JER 5:29 So, I go really ponish dem for evritin wey dem do. Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!”
JER 5:30 Sirious tins wey go make pipol sopraiz and fear, go happen for Judah:
JER 5:31 Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
JER 6:1 Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.
JER 6:2 I go distroy Zion, even doh e fine well-well and honbol like yong woman.
JER 6:3 Difren kings go kom attack am with dia sojas. Dem go build dia tent round di town kon kamp for der.
JER 6:4 Dem go sey, “Make una ready to attack Jerusalem! Make una kom make wi go attack am for aftanoon.” But leta dem go still sey, “E too late, evening don rish and di evening shadow don dey long.
JER 6:5 So, make una kom make wi go attack kon distroy all en strong-strong building for nite.”
JER 6:6 Dis na wetin Oga God wey dey mighty tok, “Make una kut all di trees for Jerusalem trowey kon build wall round am. I must ponish dis town, bikos opreshon full am.
JER 6:7 Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.
JER 6:8 So Jerusalem pipol, make dis one bi warnin to una, if not, I go forget una kon make una land empty and nobody go fit stay der.”
JER 6:9 Dis na wetin Oga God tell mi: “Di pipol wey remain for Israel, go bi like grape wey dem press well-well. So make yu go shek di branches again like sey na yu dey press di wine out. Den, make yu save di ones wey yu fit save naw wey time dey.”
JER 6:10 So I ansa, “If I go warn and tok to dem, na who go gri listin? Dia ear block, so dem nor go hear mi, bikos God word dey make dem vex well-well and dem nor like am at-all.
JER 6:11 My Oga God, just as Yu dey vex for dem, na so too I dey vex and I nor fit hide my vexnashon again.” Den God sey, “Di shidren wey dey play for di street and di yong men wey gada togeda, make yu pour my vexnashon for dia body. Dem go seize and karry husband and wife go and dem nor go even sorry for old pipol.
JER 6:12 Dem go give dia house, wifes and farms to anoda pesin. I go ponish di pipol wey dey dis land.
JER 6:13 Bikos both rish and poor pipol dey make money with wayo. Even profets and priests join dem dey deceive pipol too.
JER 6:14 Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Wen dem know sey nor bi so e bi.
JER 6:15 Shame dey katch dem bikos of di wiked tins wey dem do? No! Dem nor dey shame at-all. Dem nor even sabi form sef! So, dem go die just as odas die. Dem go die finish, afta I don ponish dem.”
JER 6:16 God tell en pipol, “Make una stop and look round. Mi, wey bi God, don tok. Ask for di old way wey bi God own and make una follow am.” But dem ansa, “Dat nor bi di way wey wi like to follow!”
JER 6:17 Den God sey, “I choose profets make dem guide and warn una about di trumpet sound!” But di pipol ansa, “Wi nor won hear anytin!”
JER 6:18 So God sey, “Make all di nashons hear mi! Make una bi witness to wetin go happen to dis pipol.
JER 6:19 Pipol for dis eart! Make una hear dis word: ‘I won bring wahala for dis pipol. E go bi payment for dia wikedness, bikos dem don rijet my law and dem nor gri listin to wetin I tok.
JER 6:20 Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’
JER 6:21 So God sey, ‘I go send sojas kom distroy dem. Papa, mama and shidren go die, even friends and neighbours go die too.’
JER 6:22 “God sey, ‘Si, sojas dey kom from one land for nort; one nashon wey dey far and dem dey ready to kom fight.
JER 6:23 Dem karry bow and swod dey kom; dem wiked well-well and dem nor dey sorry for pesin. As dem dey ride dia horse, e bi like sey na nois for sea and dem dey ready to kom fight Jerusalem pipol.’ ”
JER 6:24 I kry kon sey, “Wi don hear di news and fear dey katch us. So naw, wi dey pass thru pain like woman wey won born.
JER 6:25 So my pipol, make una nor go farm or travel go anywhere, bikos di enemies dey der with dia swod and dem dey kause wahala for evriwhere.”
JER 6:26 I still sey, “My pipol! Make una wear sak klot and roll for groun. Make una kry well-well and mourn like sey una only pikin just die. Bikos very soon, doz wiked sojas go kom distroy all of us.”
JER 6:27 God tell mi, “I don choose yu to test my pipol like who dey test iron, den yu go kom tell mi wetin dem bi like.”
JER 6:28 I ansa, “Dem bi sturbon and wiked pipol; dia heart strong like bronze and iron. Dem dey lie waka and na so-so bad-bad tins dem dey do.”
JER 6:29 Di judgement fire dey burn and e go distroy many yuzles tins. So e dey yuzles to dey try to klean my pipol, bikos wiked pipol still dey among dem.
JER 6:30 Dem go koll dem yuzles silva, bikos mi wey bi God, don rijet dem.
JER 7:1 God tell Jeremaya:
JER 7:2 “Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok.
JER 7:3 Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’
JER 7:4 Make una nor bilive di lie wey make una dey sey, ‘Wi dey save, bikos God temple dey here! Yes! God temple dey here!’
JER 7:5 Make una shange from di kind life wey una dey live kon dey do di rite tin. Make una respet each oda too.
JER 7:6 Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una.
JER 7:7 If una stop to do all dis tins, I go allow una stay for dis land wey I give una grand-grand papa as dia propaty.
JER 7:8 “But make una si una life! Una dey bilive lie-lie words wey nor go save una.
JER 7:9 Una dey tif; kill; dey sleep with who una nor marry; dey lie; dey swear; dey offa sakrifice give juju and dey woship gods wey una nor know before.
JER 7:10 Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?
JER 7:11 God sey, Una tink sey my temple na where tif dey hide put? Make una know sey I don si wetin una dey do.
JER 7:12 Make una go Shiloh, di place wey I first choose sey dem go for dey woship mi. Make una si wetin I do for der bikos of di wiked tins wey my pipol Israel, do.
JER 7:13 Una don do all dis tins and even as I tok to una rish, una nor gri listin or ansa wen I koll una make una turn kom meet mi.
JER 7:14 So, just as I distroy Shiloh, na so too I go distroy dis my temple wey una trust sey go protet una, even doh I bin gi-am to una and una grand-grand papa.
JER 7:15 Just as I porshu Israel pipol wey bi una relashon, na so too, I go porshu una komot from my front.
JER 7:16 Den God tell mi, “Jeremaya! Make yu nor pray for dis pipol. Make yu nor kry or pray give mi bikos of dem! Nor beg make I save dem, bikos I nor go listin to yu.
JER 7:17 Abi yu nor dey si all wetin dem dey do for Judah and for evry street for Jerusalem?
JER 7:18 Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.
JER 7:19 Na mi, dem tink sey dem dey do? ‘No!’ Na demsef dem dey bring wahala and shame kom meet.”
JER 7:20 So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”
JER 7:21 God still tell Judah pipol, “Una fit still go put una burnt ofrin join di oda sakrifice kon chop all of dem!
JER 7:22 Si, wen I bring una grand-grand papa dem kom out from Egypt kon tok to dem, I nor only kommand dem for wetin dem go do koncerning di burnt ofrin and sakrifice.
JER 7:23 But I kommand dem sey, ‘Make una obey mi and if una obey mi, I go bi una God and una go bi my pipol. Make una live una life as I tell una and evritin go betta for una.’
JER 7:24 But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.
JER 7:25 Since una grand-grand papa kom out from Egypt kon rish naw, I dey always send my savants, di profets kom meet una.
JER 7:26 But nobody among una dey listin or hear dem. Instead, una sturbon and wiked pass una grand-grand papa.”
JER 7:27 Den God tell mi, “Even wen yu don tell dem all dis tins finish, dem nor go still listin to yu; yu go koll dem, but dem nor go ansa yu.”
JER 7:28 So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.
JER 7:29 So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”
JER 7:30 God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty.
JER 7:31 And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.
JER 7:32 So, di time dey kom wen dem nor go koll dat place, ‘Tofet or Hinnom Valley again’, but dem go koll am, ‘Valley where dem for dey kill pipol.’ Dem go beri pipol for der, bikos know oda place go dey to beri pipol put.
JER 7:33 Den dis wiked pipol dead body go dey for groun and birds with wild animals go chop am. Nobody go remain for der to porshu di animals.
JER 7:34 For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
JER 8:1 God sey, “Wen dat time rish, Judah kings with en ofisas, priests, profets and doz wey stay Jerusalem before dem die, make yu dig dia bones kom out from dia graves.
JER 8:2 Den, put dem under sun, moon and stars. Bikos dis na di tins wey dem love; tins wey dem dey woship, serve and koll make e kom guide dem. Nobody go gada dis pipol bones go beri again; so dem go bi like manure wey dem pour for groun.
JER 8:3 But I nor go kill dis wiked pipol finish, instead I go skata dem go difren place where dem go for dey beg make dem die.
JER 8:4 God sey make I ask dem, “Pesin wey fall, nor dey get up again? Abi, pesin wey miss road, nor dey turn back go pass di korrect road?
JER 8:5 Den, wen dis pipol turn from mi, why dem nor turn back kom meet mi? Instead, dem whole dia juju tight and nor gri turn kom meet mi.
JER 8:6 I don listin to dem well-well, but dem nor dey tok trut. Nobody among dem dey feel bad for di bad tins wey dem do; no one among dem ask sey, ‘Wetin bi di bad tin wey I do?’ Instead, all of dem just dey do wetin dem wont like sey dem bi horse wey dey rush go fight.
JER 8:7 Just as bird for sky know wen to fly, na so too, dove, swallow and crane know wen to shange pozishon. But my pipol nor gri do wetin mi, wey bi God sey make dem do.
JER 8:8 How una go sey, ‘Wi wise well-well and wi know God law, wen e bi sey, doz wey dey tish di law, don shange wetin e really mean?’
JER 8:9 Shame go katch una wise men, dem go konfuse and God go judge dem, bikos dem don rijet wetin E tok. Na wish kind sense dem tink sey dem get sef?
JER 8:10 So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.
JER 8:11 Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Even wen dem know sey nor bi so e go bi.
JER 8:12 Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.”
JER 8:13 “I bin won gada my pipol, just as farmers dey gada wetin e harvest, but dem bi like vine wey nor get grape or dry fig tree wey nor get fig. Bikos of dis, I go let strenjas take dia land.”
JER 8:14 Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.
JER 8:15 Even wen wi pray for peace, na wahala dey follow us. Wi bilive sey wi go rest small, but na trobol dey porshu us.
JER 8:16 Awa enemies don already dey Dan town; wi dey hear dia horse nois and as di whole town dey shake. Awa enemies dey kom distroy awa land. Dem dey kom distroy awa town and evribody wey dey inside.”
JER 8:17 God sey, “Yes! I dey send enemies kon distroy una and dem bi like wiked snake and nobody go fit stop dem. Dem go wound and kill una well-well.”
JER 8:18 Den I sey, “Nobody fit cure my pain bikos my heart heavy well-well.
JER 8:19 I dey hear my pipol dey kry for evriwhere for di land sey, ‘God nor dey Zion? Abi Zion king nor dey der again?’ ” But God ansa, “Wetin make una go woship juju kon make mi vex?”
JER 8:20 But di pipol kon kry sey, “Dry sizin and harvest time don kom go, yet nobody kom save us.”
JER 8:21 My heart dey feel pain, bikos my pipol heart heavy; I dey kry well-well and fear dey katch mi.
JER 8:22 Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?
JER 9:1 I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
JER 9:2 I wish sey I get where I fit go stay for desert; I for go, so dat my pipol nor go fit si mi, bikos dem nor dey faithful to God.
JER 9:3 God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
JER 9:4 Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.
JER 9:5 Friends dey deceive friends and nobody dey tok trut. Dem don train demsef to dey lie and do bad tins. Dem nor gri turn from sin kom meet God.
JER 9:6 Just as dem dey do one wiked tin finish, na so dem dey start anoda one. Dis pipol nor gri listin to mi wey bi God.”
JER 9:7 So God wey dey rule evritin kon sey, “Like iron, na so too I go melt and test my pipol for fire, bikos dem don do wiked tins well-well. Abi na how I won do dem pass?
JER 9:8 Dia mout sharp like arrow and na so-so lie full am. Dem dey tok well with dia neighbours, but for dia mind, na trap dem dey set for di pesin.
JER 9:9 Make I nor ponish dem for all dis tins wey dem do? Abi make I nor distroy nashon wey bi like dis?”
JER 9:10 So I kon sey, “I go kry and mourn for di grass wey dey on-top mountin, bikos dem don dry and nobody dey travel pass der again. Dem nor dey hear fawol nois for der again and even bird and wild animals, don fly komot der.”
JER 9:11 God sey, “I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der, den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”
JER 9:12 So I ask, “Na who wise rish to undastand wetin make dis tins happen? Na who God don tell wey fit esplain why e bi like dis? Wetin make di land skata kon dry like desert wey pipol nor fit travel pass?”
JER 9:13 God ansa, “Dis tins happen, bikos my pipol rijet di law wey I give dem. Dem nor gri obey or do wetin I sey make dem do.
JER 9:14 Instead, dem get strong heart kon dey woship Baal, just as dia grand-grand papa tish dem.
JER 9:15 So, make yu listin to wetin mi, Israel God wey get pawa go do: ‘I go make dis pipol chop bitter food kon make dem drink di judgement wota wey get poizin.
JER 9:16 I go skata dem go difren nashons wey dem or dia grand-grand papa neva hear of before kon send sojas go fight dem, until I don distroy dem finish.’ ”
JER 9:17 God wey dey rule evritin sey make I tell dis pipol, “Make yu nor forget wetin I won tok so! Make yu koll di wimen and doz wey sabi kry and sing beri song, kom.”
JER 9:18 So I sey, “Yes! Make dem kwik kom sing beri song for us, so dat wi go kry and mourn well-well.
JER 9:19 Make una hear Zion pipol dey kry: ‘Wi don die finish! Dem don disgrace us well-well! Wi must komot from awa land, bikos awa house don skata.’ ”
JER 9:20 I still sey, “Naw, wimen! Make una listin and hear wetin God dey tok. Make una tish una dotas and friends how to kry and sing beri song.
JER 9:21 Bikos deat don klimb pass awa windows. E don enter awa house wey dem guide well. E don kill awa shidren wey dey play for di street and di yong men wey dey di town centre.”
JER 9:22 Make una tell una dotas and neighbours wetin God tok: “Dead body go full evriwhere like manure wey dem skata for farm or korn wey dem gada for groun.”
JER 9:23 God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.
JER 9:24 If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin.
JER 9:25 God sey, “Doz wey dem sekonsaiz, but nor dey keep di kovenant wey make dem sekonsaiz dem, time dey kom wen I go ponish dem.
JER 9:26 I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”
JER 10:1 Israel pipol, make una listin to wetin God dey tell una.
JER 10:2 Di Oga una God sey, “Make una nor do wetin oda nashons dey do; make una nor let doz signs for sky disturb una mind, even if oda nashons dey fear am,
JER 10:3 bikos dia relijon dey yuzles. Dem dey kut wood from forest kon gi-am to pesin wey dey karve and e go karve image with di wood;
JER 10:4 use silva and gold take dekorate am kon nail am make e for nor fall.
JER 10:5 Dat kind juju bi like image for farm where dem plant melon put. Di juju nor dey tok; dem must karry am waka, bikos e nor get leg. But make una nor fear dem, bikos dem nor go fit wound or help una.”
JER 10:6 I sey, “My God! Nobody bi like Yu. Yu dey mighty and yor name dey great with pawa.
JER 10:7 E nor get who nor dey fear Yu, bikos na Yu kreate evritin. Nobody bi like Yu for di whole world. Even kings and wise men nor rish Yu.
JER 10:8 Evribody for dis world na fool and dem nor get sense. Wetin dem fit learn from juju wey dem make from wood?
JER 10:9 Na silva and gold from Spain and Ufaz dem take kover di juju. Na doz wey sabi karve make am with dia hand kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave.
JER 10:10 But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.
JER 10:11 So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’
JER 10:12 Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.
JER 10:13 Wen E kommand, en vois dey sound like tonda and di wota for heaven go make nois like lion vois. E dey make kloud kom out from where di eart for end. E dey bring tonda lite wen rain dey fall and E dey make breeze blow kom from where E keep dem put.
JER 10:14 All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
JER 10:15 Di juju dey yuzles, so make dem distroy dem trowey and time dey kom wen God go ponish and distroy all of dem.
JER 10:16 Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”
JER 10:17 Jerusalem pipol! Make una pak una tins! Make una run komot di land, bikos una enemies don surround una.
JER 10:18 God sey, “I go trow una komot for dis land. Yes! I go kill all of una finish.”
JER 10:19 So I kry, “Wi don die finish! Awa own worse well-well o-o! Wi tink sey wi go fit bear dis one.
JER 10:20 Dem don distroy awa house and di rope wey bin whole di house togeda, don kut. Dem don karry awa shidren go as slave and dem nor go kom back again, bikos of dat, nobody dey to help us build awa house or hang di curtains again.”
JER 10:21 But I still sey, “Dat na bikos awa leaders nor get sense. Dem nor gri go meet God make E tell dem wetin dem go do. So dem kon do tins like fools and all di pipol wey dem dey lead, don skata finish.
JER 10:22 So make una listin! One news dey kom naw! Wahala dey kom from di nashons for nort! Dia sojas don skata and turn Judah town to desert where animals dey stay.
JER 10:23 My Oga God, wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini and dem nor get di pawa to know wetin go happen to dem.
JER 10:24 Abeg God, make Yu korrect wi wey bi yor pipol. Make Yu nor ponish us bikos Yu dey vex, if not, all of us go die finish.
JER 10:25 Make Yu vex well-well for di nashons wey nor gri woship Yu and doz wey rijet Yu, bikos dem don kill and distroy yor pipol finish kon turn awa land to desert.”
JER 11:1 God tell Jeremaya:
JER 11:2 “Make yu hear di kovenant wey I make with Israel pipol, den go tell Judah and Jerusalem pipol about am.
JER 11:3 Tell dem sey, ‘Di Oga wey bi Israel God sey, “Curse go follow doz wey nor gri obey di kovenant.”
JER 11:4 Wen I take Israel, my pipol komot from Egypt where di land bi like fire for dia body, na der I for make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipol and I go bi dia God.
JER 11:5 Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”
JER 11:6 God tell mi, “Make yu go Judah town and Jerusalem street kon tell di pipol sey, ‘Make una listin and obey my kommand!’
JER 11:7 Bikos, since I take una grand-grand papa komot from Egypt, I warn dem by mysef sey make dem obey mi and naw, I still dey warn una.
JER 11:8 But dem nor gri listin or obey mi. Instead, dem dey do as dia sturbon and wiked heart tell dem. Na dis make mi curse dem, bikos of my kovenant and dem nor gri do wetin I kommand.”
JER 11:9 Den God tell mi, “Judah and Jerusalem pipol dey plan against mi.
JER 11:10 Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.
JER 11:11 So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’
JER 11:12 Den, Judah and Jerusalem pipol go kry go meet di gods wey dem dey sakrifice to, so dat dem go kom help dem. But doz gods nor go fit save dem wen di wahala start.
JER 11:13 Judah pipol gods plenty, just as di towns wey dem get. And as Jerusalem street plenty rish, na so too di altar wey dem build for Baal juju, plenty too.
JER 11:14 So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”
JER 11:15 God tell Judah pipol, “Di pipol wey I love dey do wiked tins, so wish rite una get wey make una dey kom my temple? Una tink sey una fit offa sakrifice to stop all di bad tins wey una don do? Una dey happy to do wiked tins even wen una dey offa di sakrifice.
JER 11:16 I don first koll una olive tree wey get many fine fruit and leaf. But naw, I go kom like tonda kon put fire and e go burn di leaf, den break di branches dem.
JER 11:17 Mi, God wey dey mighty, na mi kreate una for Israel and Judah and I go bring wahala kom meet una. Yes! Na una kause dis wahala for unasef, bikos una don sin; una make mi vex wen una offa sakrifice give Baal juju.”
JER 11:18 God give mi sense make I for fit undastand evritin, den E show mi wetin di pipol dey do.
JER 11:19 Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”
JER 11:20 So I pray to God: “My Oga God wey dey rule all of us; yor judgement na true and Yu dey si wetin pipol dey tink for dia heart. Make Yu fight dis pipol for mi, bikos my life dey yor hand.”
JER 11:21 Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”
JER 11:22 So God wey dey mighty sey, “I go ponish dem! Dem go kill dia yong men for war and na honga go kill dia shidren.
JER 11:23 I don choose di time wen I go bring dis wahala kom meet Anatot pipol and wen dat time rish, nobody among dem go survive.”
JER 12:1 My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?
JER 12:2 Na Yu plant dem like tree kon make dia rut strong for groun and dem dey grow and bear betta fruit. Dem dey always tok about Yu even doh dem nor kare about Yu.
JER 12:3 But my God, Yu know mi! Yu dey si evritin wey I dey do and how I love Yu rish. Make Yu take dis wiked pipol komot like sheep wey dem won go kill. Tell us wen dem go die.
JER 12:4 Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”
JER 12:5 Den God ansa, “Jeremaya, if yu don taya to follow dis pipol run, how yu won take follow horse run? If yu nor fit stand for open land, how yu won take stay for forest near Jordan?
JER 12:6 Even yor own brodas and family dey against yu; dem don join doz wey won kill yu. Make yu nor trust dem, even doh dem dey trit yu well.”
JER 12:7 God still sey, “I don forget Israel pipol and rijet di nashon wey I choose. Doz wey I love, I don give dem to dia enemies.
JER 12:8 Pipol wey I koll my own don turn against mi like lion for forest; di way dem dey tok to mi, bi like wen lion dey shaut. So I go trit dem like sey I hate dem.
JER 12:9 My pipol attack mi like birds or hyenas and oda wiked birds dey with dem. So make all di nashons gada like wiked animals kon distroy dis pipol wey I koll my own.
JER 12:10 Naw, strenjas go distroy my vineyard; skata my farm kon turn di land wey I love to where nobody dey stay.
JER 12:11 Dem don turn am to wildaness. Di land empty and dey yuzles to mi. Di whole land don turn desert and e nor koncern anybody.
JER 12:12 Pipol don tif all di tins wey dey di land. I send sojas go distroy di land and nobody for der go get peace.
JER 12:13 My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”
JER 12:14 God sey, “I still get sometin wey I won tok about di wiked nashons wey surround Israel; di nashon wey distroy di land wey I give my pipol. I go rut dem from dia kountry like tree wey dem rut komot for groun, den I go save Judah pipol.
JER 12:15 Afta I don take dem komot dia land, I go sorry for dem kon bring each nashon kom back to en own land again.
JER 12:16 But dem must first asept my pipol relijon with dia heart and as dem make my pipol swear with dia Baal juju, na so too, dem go use my name take swear kon sey: ‘Wi swear with God wey nor dey die.’ If dem do all dis tins, I go add dem join my pipol.
JER 12:17 But I go rut and distroy any of doz nashons wey nor gri obey mi.”
JER 13:1 God tell mi, “Go buy and wear one short nika wey dem make with linen and make yu nor wosh am.”
JER 13:2 So, I kon go buy and wear am just as Oga God tok.
JER 13:3 Den God tell mi again sey,
JER 13:4 “Di short nika wey yu buy and wear so, pul and take am go Perat. Dig and hide am for one hole wey dey di rock near Eufrates River.”
JER 13:5 So I kon go hide am for Perat just as Oga God tok.
JER 13:6 Afta, God kon sey, “Go back go kollect di short nika for where yu beri and hide am put.”
JER 13:7 So I go di place kon dig di nika kom out, but I notis sey di nika don skata and tear well-well.
JER 13:8 Den God tell mi,
JER 13:9 “Na so I go take distroy Judah and Jerusalem pipol pride.
JER 13:10 Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.
JER 13:11 Just as nika fine and dey tight pesin for waist, na so I wont make Israel and Jerusalem pipol whole mi tight. So dat dem go bi my pipol wey go dey praiz and honor my name; but dem nor gri obey mi.”
JER 13:12 Di Oga wey bi Israel God kon tell mi, “Jeremaya, if yu tell Israel pipol make dem pour wine full dia wine pot, dem go ansa yu, ‘Yes! Wi know sey wine suppose full awa pot.’
JER 13:13 Den, yu go tell dem, ‘All di pipol wey dey dis land, God go give dem wine drink until di wine don katch dem: both di kings wey kom from David family, di priests, profets and all Jerusalem pipol.’
JER 13:14 E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
JER 13:15 Den I tell Israel pipol, “God don tok! So make una dey honbol and listin to am!
JER 13:16 Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.
JER 13:17 But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”
JER 13:18 God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.
JER 13:19 Enemies don surround Judah town wey dey sout and nobody go fit enter or go outside. Dem go karry evribody for Judah go as slave.”
JER 13:20 Jerusalem pipol, make una si, una enemies dey pass nort dey kom! Where di pipol wey dey kare for una, di pipol wey make una dey proud?
JER 13:21 Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?
JER 13:22 And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.
JER 13:23 Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.
JER 13:24 So dat na why God go skata una like dirty wey strong breeze blow trowey.
JER 13:25 E sey dis na wetin go happen to una, bikos una forget am kon trust lie-lie gods.
JER 13:26 Na only God go tear una klot komot for una body kon disgrace una.
JER 13:27 Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?
JER 14:1 Dis na wetin God tell Jeremaya about rain wey nor go fall.
JER 14:2 “Judah dey mourn and en pipol dey die anyhow; en pipol sleep for groun dey kry. Yes, Jerusalem pipol dey kry for help.
JER 14:3 Rish pipol send dia savant go fetch wota for well, but dem nor si wota fetch, so dem kom back with dia empty kontaina. Dem kover dia face, bikos dem dey shame and dey konfuse.
JER 14:4 Rain nor fall since so dia land dey strong and doz wey dey plant, don taya and dem nor know wetin to do.
JER 14:5 Even deer dey waka leave di pikin wey e just born for field, bikos e nor si grass chop.
JER 14:6 Wiked donkey stand on-top hill dey breath fast-fast like jackals; dem nor dey si well again, bikos dem nor si food chop.”
JER 14:7 Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.
JER 14:8 Yet, na Yu bi di only hope wey Israel get; na Yu save us from wahala. So naw, why Yu kon bi like strenja for awa land or like pesin wey dey travel kon branch stay for one nite?
JER 14:9 Why Yu bi like pesin wey nor know before dem attack am or like sojas wey nor fit save pesin? But my God, Yu still really dey with us! Wi bi yor pipol, abeg, make Yu nor abandon us.”
JER 14:10 God tok about dis pipol sey: “Dem dey run from mi and dem nor dey kontrol demsef. So, I nor dey happy with dem. I go remember all di bad-bad tins wey dem don do kon ponish dem, bikos of dia sin.”
JER 14:11 God tell mi, “Nor beg mi sey, make I help dis pipol.
JER 14:12 Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
JER 14:13 Den I sey, “My Oga God, di profets tell di pipol sey, ‘Una nor go si war again and honga go vanish from una land. God go give una peace forever and una go prosper for di land.’ ”
JER 14:14 But God ansa, “Doz profet dey lie with my name; I nor send dem or tell dem sey make dem tell di pipol anytin. Nor bi mi give dem di vishon wey dem dey tok about and wetin dem tok, na di yuzles tins wey dem tink for dia own mind.
JER 14:15 I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’
JER 14:16 And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”
JER 14:17 God sey make I tell di pipol dis word: “I dey kry both day and nite and nor-tin fit stop mi, bikos my pipol don wound and dia sore deep well-well.
JER 14:18 Anytime I dey strol outside di town, doz wey dem kill for war, na dia dead body I dey si for road and wen I enter di town, I go still si sey pipol dey die, bikos dem nor si food chop. Profet and priest dey do dia work, but dem nor know wetin dem dey do.”
JER 14:19 Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.
JER 14:20 Wi don sin against Yu wey bi God; so wi dey konfess awa sins and di ones wey awa grand-grand papa dem kommit.
JER 14:21 Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.
JER 14:22 Just as no one among di juju for dis nashon fit bring rain, na so too di sky nor fit make rain fall by ensef. So wi don put awa hope for yor hand. Na Yu bi awa God, bikos na only Yu fit do all dis tins.”
JER 15:1 Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!
JER 15:2 If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey: “ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill, na diziz go really kill dem. Doz wey dem sey go die for war, go really die for war. Doz wey dem sey na honga go kill, na honga go kill dem and doz wey dem sey dem go katch go as slave, dem go katch dem go.” ’
JER 15:3 “ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh
JER 15:4 and I go make all di pipol for di world dey fear, bikos of wetin happen. Dem go fear, bikos of wetin Judah king, Hezekaya wey Manasseh born, do for Jerusalem.” ’ ”
JER 15:5 God sey, “Jerusalem pipol, who go sorry and pity for una? Who go stop kon ask, how una dey?
JER 15:6 Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”
JER 15:7 God still sey, “Just as breeze dey blow and skata dirty for evriwhere, na so too I go skata una for evriwhere for di eart. I go distroy una wey bi my pipol kon kill una shidren, bikos una nor gri stop di bad-bad tins wey una dey do.
JER 15:8 Wimen wey dia husband go die, go plenty pass san-san wey dey near wotaside. I go kill una yong men for aftanoon kon make dia mama sofa. Na mi make dem dey sofa and fear go katch dem well-well.
JER 15:9 Di woman wey bin get seven shidren, go faint. E nor go fit breath well again. Naw wey e suppose to dey enjoy life, dem don take en pride and joy from am. E go bi like sey evening don rish even doh sun still dey shine well-well. Na shame and disgrace go follow am. And any of dem wey still dey alive, I go make dia enemies kill dem for war.”
JER 15:10 I kon sey, “Si as I dey vex! Wetin make my mama born mi at-all? Must I kworel and argue with evribody for di land! I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money, yet evribody dey curse mi.”
JER 15:11 God ansa, “I go diliver and save Jerusalem from evry attack even doh I allow dia enemies karry dem go, so dat dem go learn. But wen una enemies dey trobol, dem go run kom meet una sey make una help dem.
JER 15:12 Una wey bi like iron and bronze, una fit break di iron wey dey nort?
JER 15:13 I go send enemies kom tif una propaty and dis go bi ponishment for di sins wey una kommit for di land.
JER 15:14 I go make una serve una enemies for strenj land, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”
JER 15:15 Den I ansa, “My God! Yu know as I dey sofa. Abeg make Yu remember kon help mi. Make Yu revensh doz wey dey tok bad against mi. Nor sorry for dem, so dat dem nor go kill mi. Make Yu remember sey na bikos of Yu, dem dey curse mi.
JER 15:16 My Oga God wey dey mighty, anytime Yu dey tok to mi, I dey listin well-well and na joy and happiness full my heart, bikos I bi yor own.
JER 15:17 I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.
JER 15:18 So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”
JER 15:19 Bikos of dis, God kon sey, “If yu turn from sin kom meet God kon stop wetin yu dey tok and tink, I go take yu back and yu go bi my savant again. If yu stop to tok anyhow, yu go bi my profet again. Den di pipol go won bi like yu and yu nor go bi like dem.
JER 15:20 Bikos of dem, I go make yu bi like strong wall. Dem go fight yu, but dem nor go fit win. I dey with yu; I go protet and save yu.
JER 15:21 I go save yu from wiked pipol and doz wey like trobol.”
JER 16:1 God tell mi,
JER 16:2 Jeremaya, make yu nor marry or born shidren for dis land.
JER 16:3 Mi wey bi God go tell yu wetin go happen to di shidren wey dem born for dis land with dia papa and mama.
JER 16:4 Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.
JER 16:5 “I tell yu sey, ‘Wen anybody die, make yu nor go visit en family or mourn for am. I nor go love, bless or sorry for Judah pipol again.’
JER 16:6 Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.
JER 16:7 Nobody go karry food go give doz wey dey mourn or give dem wine drink, bikos dia mama or papa die.
JER 16:8 “Make yu nor go house where pipol for dey do party, tok-less of to follow dem sidan chop and drink.
JER 16:9 Listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok. “Dem nor go hear joy, happiness and marriage nois. Di pipol go dey alive to si all dis tins wen e dey happen.”
JER 16:10 “Wen yu don tell di pipol about all dis tins, dem go ask, ‘Why God won ponish us like dis? Wetin wi do? Wish kind sin wi kommit wey make di Oga awa God dey vex?’
JER 16:11 Den make yu tell dem, ‘God sey, “Na bikos una grand-grand papa rijet mi kon go woship oda gods. Dem forget mi and nor gri obey my law.
JER 16:12 And naw, una sin even worse pass dia own. All of una sturbon, wiked and nor dey obey mi.
JER 16:13 So, I go drive una komot from dis land go where una and una grand-grand papa nor know at-all; land where una go dey woship oda gods both for day time and for nite, bikos I nor go sorry for una.” ’ ”
JER 16:14 God sey, “Time dey kom wen pipol go stop to use mi take swear as di God wey dey alive; wey take Israel pipol komot for Egypt.
JER 16:15 Instead, dem go swear sey, ‘I bi di God wey bring Israel pipol kom out from di land wey dey nort and from all di oda kountries wey I skata dem go.’ Yes! I go bring dem kom back to dia own kountry; di land wey I give dia grand-grand papa.
JER 16:16 “But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.
JER 16:17 Bikos I dey si evritin wey dem dey do; dia wikedness nor hide from mi and e nor get where dem hide dia sin put wey I nor go si am.
JER 16:18 I go make dem pay times two for dia sin and wikedness, bikos dem don dirty my land kon pak dia yeye juju wey nor get life, full am.’ ”
JER 16:19 Den I sey, “My God! Na Yu dey protet and give mi pawa. Yu dey help mi anytime I dey for trobol. Nashons go kom from evriwhere for di eart kon sey, ‘Di gods wey awa grand-grand papa dem get, na only to lie dem know and dem nor fit save anybody.’
JER 16:20 Pipol fit make dia own gods? No! Wetin dem make, nor bi god at-all.”
JER 16:21 Den God sey, “So, I go make dis wiked pipol know my pawa and how I strong rish and dem go know sey na mi bi God.”
JER 17:1 God sey, “Judah pipol, na iron biro dem take rite una sin; na diamond pin dem take karve am for una heart and di altar korna.
JER 17:2 Una shidren nor dey ever forget di altar and di Asherah juju wey una put near evry green tree; on-top di hill
JER 17:3 and for di mountin wey dey di open kountry. Bikos of di sins wey una don kommit for di land, I go make una enemies karry una propaty and di tins wey una like well-well.
JER 17:4 Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”
JER 17:5 God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.
JER 17:6 Dem go bi like bush for desert or for groun where nor-tin go for fit grow. Betta tin nor go ever happen to dem.
JER 17:7 But I go bless doz wey trust mi. Pipol wey bilive sey I go save dem.
JER 17:8 Dem go bi like tree wey dem plant for near river wey en rut spread enter di wota. Dem nor dey fear wen hot weda kom and dia leaf dey always green; dem nor dey borda if rain nor fall and dem dey always bring fruit.
JER 17:9 Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?
JER 17:10 Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.
JER 17:11 Pesin wey dey make money with wayo, bi like bird wey dey hash egg wey e nor lay. Wen e don dey old, e go luz all di money wey e get, den e go know sey e bi fool.”
JER 17:12 So I sey, “My God, na from di biginnin Yu sidan for yor throne wey get glory. Na only Yu bi di Pesin wey go fit save us.
JER 17:13 Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”
JER 17:14 My God, make Yu heal mi and I go strong again; save mi and I go dey save, bikos na Yu I dey praiz.
JER 17:15 Di pipol dey ask, “Where di tin wey God sey E won do us? Make E kom do dem naw make wi si!”
JER 17:16 But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.
JER 17:17 Nor make mi fear Yu, bikos na Yu dey save mi wen I dey trobol.
JER 17:18 Pipol wey dey tok bad against mi, make Yu disgrace dem kon save mi. Make fear katch dem, but nor make mi dey fear. Distroy and break dem into pieces.
JER 17:19 God tell mi, “Make yu go stand for di gate wey Judah king dey pass komot from di town and enter back and yu go still go stand for all di oda gates wey dey for Jerusalem too.
JER 17:20 Den tell di king; Judah pipol, doz wey dey stay for Jerusalem and evribody wey dey pass di gates sey, ‘Make una listin to wetin God tok.
JER 17:21 God sey, “If una value una life well-well, for Sabat Day, make una nor karry any load pass di gates for Jerusalem
JER 17:22 or bring anytin kom out from una house or do any work. But make una si am as holy day for God, just as I kommand and tell una grand-grand papa dem.
JER 17:23 But una grand-grand papa nor listin to mi, bikos dem sturbon and nor gri obey or learn from mi.” ’
JER 17:24 “God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.
JER 17:25 If una do am, den di kings and di prince go enter Jerusalem gates kon get di same royal pawa wey David get. Dem with Judah and Jerusalem pipol go ride dia horse and Jerusalem town go always dey full with pipol.
JER 17:26 Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple.
JER 17:27 But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”
JER 18:1 God tell mi,
JER 18:2 “Make yu go di house wey dem for dey make pot and I go tok to yu for der.”
JER 18:3 So I go der kon si di man wey dey make pot wen e dey mold one pot.
JER 18:4 But wen e si sey di tin wey e dey mold nor good as e wont, e skata am kon start again.
JER 18:5 Den God tell mi,
JER 18:6 “Israel pipol, I nor get rite to do una wetin di man wey dey mold pot dey do with di klay? Just as klay dey di pesin wey dey make pot hand, na so too una dey my hand.
JER 18:7 If I sey I go rut, break or distroy any nashon or kingdom
JER 18:8 and dat nashon stop to dey disobey mi, I nor go do wetin I bin sey I go do.
JER 18:9 And if I sey I go plant or build any nashon or kingdom
JER 18:10 and dat nashon disobey mi and do bad-bad tins, I nor go do wetin I sey I go do.
JER 18:11 So naw, tell Judah and Jerusalem pipol sey, ‘I dey plan and dey ready to ponish dem.’ Tell dem make dem stop to dey sin kon shange di way dem dey live dia life and di tins wey dem dey do.
JER 18:12 But dem go sey, ‘No! Wetin go make us shange? Wi go do anytin wey wi wont! Awa heart strong and wi go do all di wiked tins wey wi wont.’ ”
JER 18:13 God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.
JER 18:14 Snow dey finish on-top Lebanon rock? Or wota wey dey flow for mountin dey ever stop?
JER 18:15 But my pipol don forget mi, dem dey burn incense give juju and na dis make dem fall komot for di way wey dem suppose follow. Dem nor dey follow di road wey I show dem, instead dem dey follow di road wey nor smooth at-all.
JER 18:16 Naw, di land go turn to where pipol go dey fear and hate. All di pipol wey go pass am, go sopraiz and shake dia head, bikos of wetin dem si.
JER 18:17 I go distroy dem for dia enemies front like san-san wey breeze dey blow kom from east. I go turn my back and I nor go help dem wen di wahala go start.”
JER 18:18 Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”
JER 18:19 So, I kon pray: “My God, make Yu hear and listin to wetin my enemies dey tok about mi.
JER 18:20 Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.
JER 18:21 But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.
JER 18:22 Make tif karry evritin wey dem get for dia house, so dat dem go kry well-well. Bikos dem don dig whole make I fall put kon set trap make e katch mi.
JER 18:23 But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”
JER 19:1 God tell Jeremaya, “Make yu take some leaders and priest go buy pot wey dem take klay make.
JER 19:2 Make una pass Potsherd Gate go Ben-Hinnom Valley. Den yu go tell dem wetin I tell yu, for der.
JER 19:3 “God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!
JER 19:4 I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.
JER 19:5 Dem build altar for Baal juju, so dat dem go fit sakrifice dia shidren gi-am. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.
JER 19:6 So mi wey bi God dey sey, “Time dey kom wen pipol nor go koll dis place Tofet or Ben-Hinnom Valley again, but dem go dey koll am, di Valley Where Dem For Dey Kill Pipol!”
JER 19:7 Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.
JER 19:8 I go distroy dis place well-well. Pipol wey dey pass go shok and shake dia head, bikos of wetin happen.
JER 19:9 Wen dia enemies surround di town won kill dem, I go make dem chop dia shidren and dem go still chop each oda too.’ ”
JER 19:10 God still sey, “Naw, make yu break di pot for di pipol front
JER 19:11 kon tell dem, ‘Oga God wey dey mighty sey, “Just as Jeremaya take distroy dis pot, na so too I go distroy dis town and di pipol wey dey stay inside. Dem go beri pipol for Tofet, until place nor go dey again to beri pipol put.
JER 19:12 I don promise and I must make dis town and di pipol, bi like Tofet.
JER 19:13 Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”
JER 19:14 Den, Jeremaya komot from Tofet where God for tok to mi kon go stand for di kourt wey dey di temple front, den tell all di pipol wetin
JER 19:15 Israel God wey dey mighty tok: “I go soon ponish dis town and di oda towns wey surround am, bikos una sturbon well-well and una nor gri listin to wetin I tok.”
JER 20:1 Wen Imma pikin Pashhur wey bi di priest and wey dey guide di temple
JER 20:2 e kon oda sey make dem beat and tie mi with shain, den put mi for one room near Benjamin Gate for di temple.
JER 20:3 But di next day, afta Pashhur don release mi, I kon tell am, “God nor koll yu Pashhur, but di name wey E give yu na, ‘Fear Dey Evriwhere.’
JER 20:4 God sey, ‘I go make yu dey fear yorsef and yor friends go dey fear yu too. Yu go dey si as dia enemies go kill dem finish. I go make Judah pipol serve Babilon king and e go take some of dem go en kountry as slave kon kill di odas.
JER 20:5 I go still make dia enemies tif dia propaty kon seize all di betta-betta tins. Dem go karry Judah king propaty go Babilon.
JER 20:6 Pashhur! Dem go karry yu with yor family go Babilon. Yu go die and yu with all yor friends wey yu lie give, dem go beri una for der.’ ”
JER 20:7 My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.
JER 20:8 Na only bad-bad tins and deat I dey profesy about. Na only curse and trobol yor message don bring kom meet mi.
JER 20:9 But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.
JER 20:10 I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”
JER 20:11 But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
JER 20:12 My God wey dey mighty; Yu dey give korrect judgement to pipol and Yu know wetin dey dia heart and mind. So, make I si how Yu won take revensh my enemies, bikos I don put my problem for yor hand.
JER 20:13 Make wi sing to God! Make wi praiz God, bikos E save doz wey wiked pipol dey opress.
JER 20:14 I curse di day wey dem born mi! Make dem forget di day wey my mama born mi!
JER 20:15 Make curse follow di pesin wey kon make my papa happy wen e tell am sey, “Na boy yor wife born.”
JER 20:16 Make di pesin bi like town wey God nor sorry for wen E dey distroy tins. Make e hear pipol dey kry with pain for morning and na war kry go full en ear for aftanoon.
JER 20:17 Bikos if to sey e kill mi before dem born mi, my mama belle for bi my grave and I for dey der forever.
JER 20:18 Why dem born misef? Na make I for si trobol and always dey kry, so dat my life go end with shame.
JER 21:1 King Zedekaya send Pashhur wey Malkijah born and Zefanaya, di priest wey bi Maaseaya pikin, go meet Jeremaya, but God don tell Jeremaya before dem rish der. Zedekaya sey make dem tell Jeremaya sey,
JER 21:2 Make yu help us beg God, so dat E go kom save us, bikos King Nebukadnezzar for Babilon dey kom attack us. May bi God go do en mirakle, just as E do before kon stop King Nebukadnezzar, so dat e nor go kom attack us again.
JER 21:3 Jeremaya ansa dem, “Make una go tell King Zedekaya sey
JER 21:4 Israel God sey, ‘I go distroy yor sojas wey dey fight against Babilon king and en sojas. I go bring dia sojas kom di town centre.
JER 21:5 Na with all my pawa, vexnashon and fire, I go take fight against yu.
JER 21:6 I go kill evribody for dis land. Na bad diziz I go take kill both di pipol and dia animals.
JER 21:7 Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
JER 21:8 God still sey make I tell di pipol, “Make una listin! Mi wey bi God, dey give una shance to choose between dis two tins: ‘Di way wey dey lead to life or di one wey dey lead to deat.’
JER 21:9 War or honga go kill anybody wey dey di town, but doz wey go kom out kon surenda give Babilon king, nor go die; dem go eskape with dia life.
JER 21:10 Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun.
JER 21:11 God sey make I tell David shidren-shidren wey dey di royal house for Judah sey,
JER 21:12 “Make una listin to wetin mi wey bi God dey tok. Make una make sure sey dem dey always give korrect judgement for kourt. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am and bikos of di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire wey nor dey kwensh.
JER 21:13 Jerusalem wey dey on-top di valley like rock wey high well-well, make yu listin to mi. I go fight against yu, bikos yu sey, ‘Nobody go fit attack or skata awa town.’
JER 21:14 But I go ponish yu for wetin yu don do. I go lite fire put for yor palis and di fire go burn evritin finish.
JER 22:1 God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:
JER 22:2 ‘Judah king wey sidan for David throne, en ofisas and all en pipol wey dey pass dis gate, make una listin.
JER 22:3 Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
JER 22:4 If una really do wetin I kommand, den David shidren-shidren go kontinue to bi king. Both dem, dia ofisas and dia pipol go kontinue to ride horse pass dis palis gate.
JER 22:5 But I swear sey, if una nor obey my kommand, dem go distroy dis palis rish groun.
JER 22:6 “Even doh Judah royal palis fine like Gilead land and Mount Lebanon, I go turn am to desert and pipol nor go stay der again.
JER 22:7 I go send men kon distroy am. Dem go use dia axe take kut en fine cedar pilas kon trow dem for fire.
JER 22:8 Wen pipol from oda nashons dey pass, dem go dey ask each oda, ‘Wetin make God do dis kind tin to dis great town.’
JER 22:9 Den, some go ansa, ‘Na bikos dem forget dia kovenant wey dem make with dia God kon go serve and woship oda gods.’
JER 22:10 “Judah pipol, make una nor kry and mourn for di king wey dem kill. But make una kry well-well for di one wey dem go karry go Babilon, bikos e nor go kom back to di land where dem for born am again.”
JER 22:11 Dis na wetin God tok about Josaya wey bi Shallum pikin, wey take-ova from en papa as king, before dem karry am go Babilon. God sey, “E nor go ever kom back to dis land again.
JER 22:12 E go die as slave for di kountry where dem dey karry am go and e nor go si dis land again.”
JER 22:13 “E go bad for di king wey build big house with lie-lie and wayo. Di king wey make di men dey work for nor-tin and nor gri pay dem dia salari.
JER 22:14 E go bad for di king wey sey, ‘I go build big house for mysef; di room for up go get betta space.’ So e put windows for di house, use cedar wood take dekorate am kon paint am with red kolour.
JER 22:15 If yu take cedar wood build house and e fine pass oda pipol own, na dat one make yu bi betta king? Yor papa enjoy life well-well, bikos e always dey good and kind, so e prosper for evritin wey e do.
JER 22:16 E judge poor pipol well and evritin go well with am, den God kon sey, ‘Dat na betta ezample to show sey yu know mi.’
JER 22:17 But yu dey always tink and look for ways to use wayo take make plenty money. Na to kill innocent pipol and opress yor own pipol, yu dey always tink.
JER 22:18 So, dis na wetin God tok about Josaya pikin, King Jehoiakim for Judah: ‘Nobody go mourn wen e die or tell en neighbour, “My friend, di king deat dey vex and pain mi!” Nobody go kry for am sey, “My oga and my king don die!” ’
JER 22:19 Just as dem nor dey beri donkey wey die, na so too dem nor go beri am. Dem go drag en body komot from di town kon trow am outside Jerusalem.”
JER 22:20 Jerusalem pipol, make una shaut and mourn as una dey go Lebanon. Make una kry go Bashan land; make una shaut well-well for Moab mountins, bikos dem don distroy una propaty.
JER 22:21 Wen una dey prosper and enjoy, God tok to una, but una nor gri listin. Na so una dey bihave since and una nor gri obey God.
JER 22:22 So breeze go blow una leaders trowey; dem go karry all una tins go. Den, dem go disgrace and make una shame, bikos of all di wiked tins wey una do.
JER 22:23 Una fit tink sey una dey save like bird wey dey rest for Lebanon cedar. But wen di wahala kom, una go kry with pain like woman wey won born.
JER 22:24 God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
JER 22:25 I go give yu to doz wey yu dey fear and wey won kill yu. I go give yu to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas.
JER 22:26 I go force yu and yor mama wey born yu, go anoda kountry. Una go-go kountry where dem nor for born una and una go die for der.
JER 22:27 Yu go like to kom back to dis kountry, but yu nor go ever kom back again.”
JER 22:28 I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
JER 22:29 Judah land, Judah land, Judah land! Make una listin to wetin God won tok:
JER 22:30 God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”
JER 23:1 “E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
JER 23:2 Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.
JER 23:3 I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.
JER 23:4 I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again.
JER 23:5 God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
JER 23:6 Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”
JER 23:7 God sey, “Di time dey kom, wen pipol nor go use my name take swear sey, ‘Yu bi God wey dey alive wey take Israel pipol komot from Egypt.’
JER 23:8 Instead dem go sey, ‘Yu bi di God wey dey alive wey bring Israel pipol kom back from di land for nort and from di oda kountries wey Yu skata dem go.’ For dat time, dem go dey dia own land.”
JER 23:9 Dis na wetin God tok about lie-lie profets: “Dem don break my heart and all my body dey shake. I bi like pesin wey don drink wine well-well, bikos of di wey dem dey trit mi and my holy word.
JER 23:10 Na pipol wey nor dey faithful, full di land and dem dey live wiked life kon dey use dia pawa anyhow. Di pipol dey mourn and all di green leaf don dry, bikos God don curse dia land.”
JER 23:11 God sey, “Di profets and priests nor know mi; I katch dem dey do wiked tins for my temple.
JER 23:12 So di road wey dem dey pass, go dark and go dey draw; I go make dem kick stone fall. I go bring wahala kom meet dem and di time to ponish dem, don near.
JER 23:13 God sey, “I dey si di sins wey Samaria profets dey kommit; dem dey profesai with Baal name kon lead my pipol komot from di trut.
JER 23:14 But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.
JER 23:15 So, dis na wetin mi wey bi God dey tok about Jerusalem profets: ‘I go give dem bitter food chop kon give dem wota wey dem poizin, drink, bikos dem don spread sin for di whole land.’ ”
JER 23:16 God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol: “Make una nor listin to wetin doz lie-lie profets dey tell una; na yeye hope dem dey give una. Nor bi wetin I tell dem, dem dey tell una, but na wetin dem tink and like, dem dey tok.
JER 23:17 Pipol wey nor gri listin to wetin God tok, dem dey tell dem sey, ‘Evritin go-go well with una!’ And dem dey tell sturbon pipol sey, ‘Bad tins nor go happen to una at-all!’
JER 23:18 So, I sey, Nobody among dis profets know wetin God dey tink for sekret. No one don ever hear or undastand en message or listin to wetin E tok.
JER 23:19 But just look, God vexnashon go kom like heavy breeze and e go blow wiked pipol head komot.
JER 23:20 E nor go end until E don do evritin wey E plan to do. Di time dey kom wen di pipol go undastand all dis tins well.”
JER 23:21 God sey, “I nor send all dis profets, but dem dey rush go tok dia own message. I nor tell dem anytin, but dem still dey profesai.
JER 23:22 How I wish dem know wetin I dey tink for my mind, den dem for fit prish my message give my pipol, so dat dem go stop di kind life wey dem dey live and di bad-bad tins wey dem dey do.
JER 23:23 Abi una tink sey I bi God wey dem tie put for one place? No! I dey evriwhere.
JER 23:24 E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?
JER 23:25 “I know evritin wey doz profets tok; dem dey lie with my name sey I tok to dem thru dreams.
JER 23:26 How long e go take for doz profets to stop to dey deceive my pipol with dia lie-lie word?
JER 23:27 Dem tink sey di dream wey dem dey tok so, go make my pipol forget mi, just as dia grand-grand papa forget mi kon dey follow Baal?
JER 23:28 Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree.
JER 23:29 My message bi like fire and na hammer wey dey break rock into pieces.
JER 23:30 I hate all doz profets wey dey listin to oda profets words kon tell my pipol sey na mi tok am.
JER 23:31 I still dey against doz profets wey dey tok dia own word kon sey na mi tell dem.
JER 23:32 Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all.
JER 23:33 God tell mi, “Jeremaya, if anybody among my pipol, or profet or priest ask yu, ‘Wetin God tok?’ Make yu tell dem sey, ‘Una dey disturb God and E go distroy una.’
JER 23:34 I go ponish anybody, profet or priest wey sey, ‘God message na wahala!’ I go ponish di pesin and all en family.”
JER 23:35 So mi, Jeremaya dey tell una sey, “Make una dey ask una friend or relashon, ‘Wish ansa God give and wetin God tok?’
JER 23:36 So make una nor sey God message na wahala, bikos if anybody tok like dat, den di message go bi wahala to am. Di pipol don shange dia God; di Almighty God wey dey alive, dem don shange en word.
JER 23:37 So Jeremaya, ask di profets, ‘Wish ansa God give una or wetin God tok?’
JER 23:38 But if dem nor obey my kommand kon sey, ‘God message na wahala,’ den yu go tell dem sey,
JER 23:39 ‘God go trow una far from am; both una and di town wey E give una and una grand-grand papa.’
JER 23:40 I go disgrace dem forever and dem nor go forget am.”
JER 24:1 Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.
JER 24:2 Na good fig full di first basket; figs wey kwik ripe; but na bad fig wey dem nor go fit chop dey di sekond one.
JER 24:3 Den God tell mi, “Jeremaya, wetin yu dey si?” I ansa, “Na fig! Di good ones don ripe, while di bad ones don spoil.”
JER 24:4 So God tell mi,
JER 24:5 “Mi, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Di pipol wey dem karry go Babilon bi like dis good fig and I go trit dem well with kindness.
JER 24:6 I go kare for dem kon bring dem kom back to dis land. I go karry dem up and nor-tin go fit bring dem down. I go plant dem and nor-tin go fit rut dem.
JER 24:7 I go let dem know sey na mi bi God. Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God, bikos dem go kom back kon serve mi with all dia heart.
JER 24:8 “ ‘But King Zedekaya for Judah, en ofisas and di pipol wey remain for dis land and doz wey go Egypt, mi wey bi God, go trit dem like dis bad fig wey don spoil.
JER 24:9 I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.
JER 24:10 I go bring war, honga and diziz kom meet dem, until nobody among dem go remain for di land wey I give dem and dia grand-grand papa.’ ”
JER 25:1 For di fourt year wey Jehoiakim, Josaya pikin bi king for Judah, God tok to Jeremaya about all di pipol for Judah. (Dis na di first year wey Nebukadnezzar dey rule for Babilon.)
JER 25:2 So I tell Judah and Jerusalem pipol:
JER 25:3 “For twenty-three years, from di thirtint year wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah kon rish naw, na-im God don dey tok to mi and I nor dey fail to tell una wetin E tok, but una nor gri listin.
JER 25:4 Una nor go listin or hear, even doh God dey always send en savants kom meet una.
JER 25:5 Dem tell una make una shange di kind life wey una dey live kon stop all di wiked tins wey una dey do, so dat una go kontinue to dey stay for dis land wey God give una and una grand-grand papa.
JER 25:6 Dem sey make una nor woship or serve oda gods and make una nor make God vex bikos una dey woship juju. So, if una obey God, E nor go ponish una.
JER 25:7 But God sey una nor gri listin to am. Instead, una dey make am vex with doz una juju kon bring ponishment for una head.
JER 25:8 “So, bikos una nor gri listin to am, God wey dey mighty sey,
JER 25:9 ‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.
JER 25:10 I nor go make una happy or do marriage again. Una nor go si oil pour for una lamp and korn nor go dey for una to chop.
JER 25:11 Dis land go empty, So Israel pipol and doz wey dey stay near dem, go serve Babilon king for seventy years.’
JER 25:12 “ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.
JER 25:13 I go make evritin wey I tok happen for dat land; evritin wey dem rite for dis book wey Jeremaya profesai against dis nashon, must happen.
JER 25:14 I go pay Babilon pipol back for wetin dem do and dem go bi slave to many nashon and great kings.’ ”
JER 25:15 Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am.
JER 25:16 Wen dem drink am finish, dem go stagga kon dey bihave anyhow, bikos I dey send war kom meet dem.”
JER 25:17 So I take di cup from God hand kon go di nashons wey God send mi go and I make all of dem drink from am.
JER 25:18 I go make Jerusalem and all di towns for Judah, dia kings and all dia ofisas drink from am, so dat di land go turn to desert, where dem dey trow dirty put and wen pipol si am, dem go shok with fear. Den pipol go use dia name dey curse pipol, just as dem don already dey use am.
JER 25:19 Dis na di oda pipol wey drink from di cup: King Fero for Egypt; doz wey dey serve am; en ofisas, en pipol;
JER 25:20 di strenjas for Egypt; di kings for Uz land; di kings for Filistia land, Ashkelon, Gaza, Ekron pipol and di pipol wey dem nor kill for Ashdod town;
JER 25:21 Edom, Moab and Ammon pipol;
JER 25:22 di kings for Tyre, Sidon and di lands near di sea;
JER 25:23 Dedan, Tema, Buz and all di pipol for desert wey kut dia hair short as dem dey di temple;
JER 25:24 di kings for Arabia wey dey stay desert;
JER 25:25 Zimri, Elam and Media kings;
JER 25:26 di kings for nort both far and near and all di kingdoms wey dey dis eart. Afta all of dem don drink from God vexnashon cup finish, Babilon king must drink from am too.
JER 25:27 Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.
JER 25:28 And if dem nor gri take di cup from yor hand kon drink from am, den tell dem: ‘God wey dey mighty sey una go must still drink from am.’
JER 25:29 Bikos na from my own town I go for start to distroy kom rish dia own. Dem tink sey dem nor go ponish dem? No! Dem go ponish dem, bikos I go send war kom meet evribody for di eart.
JER 25:30 “So, Jeremaya, make yu tell dem evritin wey I tok. Yu must tell dem sey, ‘Like lion wey won attack, na so too God go shaut from heaven! E go shaut for en pipol from en holy place. E go shaut like pesin wey dey mash grape wey dem won take do wine and evribody for di world go hear am.’
JER 25:31 Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol.
JER 25:32 God wey dey mighty sey, “Wahala go kom meet di nashon one-by-one and strong breeze go gada for where di world for end.
JER 25:33 For dat day, di pipol wey God kill, dia body go skata for difren part for di world. Nobody go mourn for dem and nobody go karry dem go beri. Dem go dey groun like manure wey dem gada.
JER 25:34 Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat
JER 25:35 and una nor go fit eskape.
JER 25:36 Una dey kry with pain, bikos God don use en vexnashon distroy una nashon
JER 25:37 kon skata una kountry wey bin get peace.
JER 25:38 God don forget en pipol like lion wey waka komot for en kage go find food. Dia kountry don turn desert, bikos dem dey fear pipol wey dey opress dem and dem dey fear God vexnashon too.”
JER 26:1 As Josaya pikin, Jehoiakim just start to rule for Judah, God kon tell Jeremaya
JER 26:2 sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu.
JER 26:3 May bi dem go listin kon stop to do di wiked tins wey dem dey do. If dem stop, I go shange my mind and I nor go distroy dem again.
JER 26:4 Tell dem sey di Oga wey bi God sey, ‘Una must obey mi and do wetin I tish una.
JER 26:5 My savants wey I send kom meet una, make una dey listin to evritin wey dem tell una. I dey always send dem kom meet una, but una nor gri listin to dem.
JER 26:6 If una nor gri obey mi, den I go distroy dis temple, just as I distroy Shiloh. I go make sure sey evribody for dis eart dey curse dis town.’ ”
JER 26:7 As I dey tok for God temple, di priests, profets and di pipol, dey hear mi.
JER 26:8 So, as I just tok finish, dem kon seize mi dey shaut, “Wi suppose kill yu, bikos of dis rubbish wey yu dey tok so!
JER 26:9 Wetin make yu dey tok all dis foolish tins with God name? Wetin make yu dey tok with en name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipol kon gada round mi.
JER 26:10 Wen di leaders hear wetin happen, dem rush kom di temple from di royal palis. Dem kon form one kourt for where di New Gate for God temple dey.
JER 26:11 Den di priests and di profets kon tell di leaders and di pipol sey, “Make dem kill dis man, bikos e don tok against awa town. All of una hear as e dey tok.”
JER 26:12 Den I sey, “Na God send mi kom tell una evritin wey I tok about dis temple and dis town.
JER 26:13 Una must shange kon obey di Oga una God. Una must stop to live di bad life and wiked tins wey una dey do. If una stop am, God go shange en mind and E nor go distroy una.
JER 26:14 As for mi, I dey una hand, so una fit take mi do anytin wey una like.
JER 26:15 But make una know sey, if una kill mi, una and di pipol for dis town nor go get rest, bikos una don kill innocent pesin wey God send kom warn una.”
JER 26:16 Den di leaders and di pipol kon tell di priests and di profet sey, “Na God name dis man take tok to us, so make wi nor kill-am.”
JER 26:17 Afta, some of di leaders stand kon tell di pipol,
JER 26:18 “Wen Hezekaya bi king for Judah, Profet Mikah from Moreshet profesai give di pipol. E tell dem sey, ‘God sey, “ ‘ “Dem go klear Zion like field; Jerusalem go turn where dem dey trowey dirty put and di temple hill go turn forest.” ’
JER 26:19 “King Hezekaya and di pipol nor kill Mikaya, abi dem kill-am? But King Hezekaya honor God kon try to win en favor. So, God kon shange en mind and E nor distroy dem again. But as e bi so, wi dey won kause sirious wahala for awasef.”
JER 26:20 (Naw, e get anoda man wey profesai with God name against di pipol and di town, just as Jeremaya dey profesai. En name na Uriaya wey Shemaya born and e kom from Kiriat-Jearim.
JER 26:21 And wen King Jehoiakim, en sojas and ofisas hear wetin Uriaya tok, e kon try to kill-am, but Uriaya hear kon run go hide for Egypt, bikos e dey fear.
JER 26:22 Den King Jehoiakim send Akbor pikin Elnatan and some oda men go Egypt go katch Uriaya kom.
JER 26:23 Dem bring am kon give King Jehoiakim wey kill and beri am for where dem dey beri ordinary pipol put.)
JER 26:24 So dat day, Ahikam wey bi Shafan pikin, support and help mi, so dat di pipol nor go kill mi.
JER 27:1 Wen Josaya pikin Zedekaya just bi king for Judah, God tell mi
JER 27:2 “Make yu tie leda rope for wood kon put am for yor neck,
JER 27:3 den use am take send message go give Edom, Moab, Ammon, Tyre and Sidon kings thru di pesin wey dey ripresent dem wey dem send kom si King Zedekaya, for Judah.
JER 27:4 Tell dem make dem tell dia kings sey: ‘Israel God wey dey rule ova evritin sey:
JER 27:5 “Na with my mighty pawa and great strent I take kreate di eart, di pipol and di animals wey dey inside and I don give dis pawa to pipol wey I like gi-am to.
JER 27:6 Na mi put di nashons under my savant pawa, King Nebukadnezzar for Babilon and I kon make wild animals dey serve am.
JER 27:7 All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.
JER 27:8 But if oda nashon or kingdom nor gri serve or respet King Nebukadnezzar for Babilon, I go ponish dat nashon with war, honga, diziz and I go distroy am.
JER 27:9 Nor listin to anybody or profet wey sey e know wetin go happen tumoro; doz wey dey undastand dream; doz wey dey koll dead body or doz wey dey do majik; wey sey make una nor respet Babilon king.
JER 27:10 Make una nor listin to doz wey dey deceive una, bikos dis tin fit make dem karry una far; go where una nor know. I go drive una komot from una land and una go die for der.
JER 27:11 But if any nashon gri kon serve Babilon king, I go make dat nashon stay and chop from en own land.
JER 27:12 I tell King Zedekaya for Judah di same tin sey, “Make yu honbol yorsef kon respet Babilon king; serve en and en pipol and yu go dey save.
JER 27:13 Why yu wont make honga, war and diziz kill yu and yor pipol? Dat na wetin God don sey go happen to any nashon wey nor gri obey Babilon king.
JER 27:14 Nor listin to di profets wey sey make yu nor surenda to am; dem just dey deceive yu.
JER 27:15 God don sey, ‘I nor send dem and dem dey lie give yu with my name.’ So E go drive yu komot and dem go kill both yu and di profets wey dey lie give yu.”
JER 27:16 Den I tell di priest and di pipol: “God sey: ‘Nor listin to di profets wey sey dem go soon bring all di betta-betta tins for di temple kom back from Babilon. Dem just dey lie give yu.
JER 27:17 Nor listin to dem! Obey Babilon king and yu go dey save! Why yu wont make dis town turn to where dem go dey trowey dirty put?
JER 27:18 If dem really bi profet or get my message, make dem pray give mi, di God wey dey mighty sey, “Make Yu nor allow dem karry all di betta-betta tins wey remain for di temple and palis, go Babilon.
JER 27:19 Di God wey dey mighty don already tok about di two pila wey dem make with bronze; di sea, di stands and di tins wey remain for di town
JER 27:20 wen Nebukadnezzar, Babilon king kon karry Judah King, Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and en ofisas for Judah and Jerusalem, go Babilon as slave.
JER 27:21 So, make una listin to wetin mi wey bi Israel God wey get pawa dey tok about di betta-betta tins wey remain for Jerusalem temple and palis:
JER 27:22 Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place.
JER 28:1 Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,
JER 28:2 “Israel God wey dey mighty sey: ‘I don break Babilon king pawa.
JER 28:3 Before two years go finish, I go bring all di betta-betta tins wey King Nebukadnezzar karry go Babilon kom back to dis place.
JER 28:4 Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa.
JER 28:5 Den for di priest and all di pipol wey stand for di temple present, I kon tell Hananaya sey:
JER 28:6 “Amen! Make God make yor profesy, happen! Make E bring all di betta-betta tins wey dem take from en temple and all di pipol wey dem karry go Babilon as slave kom back to dis place.
JER 28:7 But make yu listin to wetin I dey tell yu and di pipol:
JER 28:8 ‘Before-before, di profet wey tok before mi and yor time, don sey: “War, honga and diziz go kom many nashon and kingdom wey get pawa.” ’
JER 28:9 But if one profet, profesai peace and good life and e kon happen as e tok, den dat show sey na God really send am.”
JER 28:10 Hananaya take di wood wey dem tie for my neck komot kon break am to pieces,
JER 28:11 den e tok for evribody present sey, “God sey dis na how e go take break di load wey King Nebukadnezzar put for di nashons neck and E go do am before two years go finish.” So Profet Jeremaya kon waka go.
JER 28:12 Afta sometaim, God sey make
JER 28:13 I go tell Hananaya: “Yu don really break di yoke wey dem make with wood, but naw, na iron yoke yu don put for where e bin dey.
JER 28:14 Israel God wey dey mighty dey sey, ‘I don put iron yoke for dis nashon and dem go serve King Nebukadnezzar for Babilon. I go even make wild animals serve Babilon king.’ ”
JER 28:15 Den I tell Hananaya, “Make yu listin to mi! God nor send yu and yu dey make dis pipol bilive yor lie-lie story.
JER 28:16 So before dis year go end, God go kill yu by ensef, bikos yu don make di pipol dey tok against God.”
JER 28:17 Just as Jeremaya tok, Hananaya die for di seven mont for dat same year.
JER 29:1 Dis na di leta wey I rite go give di priests, profets, leaders and all di oda pipol wey Nebukadnezzar karry as prisona from Jerusalem go Babilon.
JER 29:2 I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.
JER 29:3 I give di leta to Eleasah wey bi Shafan pikin and Gemaraya wey Hilkaya born and na-im King Zedekaya for Judah send go meet King Nebukadnezzar for Babilon. Dis na wetin dey di leta:
JER 29:4 “Israel God wey dey mighty dey tell di pipol wey Babilon king karry from Jerusalem go as prisona sey:
JER 29:5 ‘Make una build house kon setol down, den plant seeds and chop anytin wey e produce.
JER 29:6 Make una marry kon born shidren. Make una shidren marry kon born shidren too, so dat una go plenty for di land.
JER 29:7 Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too.
JER 29:8 Mi wey bi Israel God dey warn una. Make una nor let di profets wey dey stay among una or any oda pesin wey klaim sey e dey si tumoro, deceive una. Make una nor listin to dia dreams.
JER 29:9 Dem dey lie with my name, but I dey tell una naw sey I nor send dem kom meet una.’
JER 29:10 “God sey, ‘Wen di seventy years wey I give Babilon don finish, I go kare and bring una kom back to una land, just as I promise.
JER 29:11 Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get.
JER 29:12 Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.
JER 29:13 Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una.
JER 29:14 Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon.
JER 29:15 “Una sey, ‘God don give una profet for Babilon wey go give us good news.’
JER 29:16 But make una listin to wetin God tok about di king wey dey rule David kingdom and di pipol for di town wey bi una relashon, wey dem nor karry as prisonas follow una.
JER 29:17 God wey dey mighty sey, ‘I dey bring war, honga and diziz kom meet dem and I go make dem bi like rotin fig fruit wey nobody fit chop.
JER 29:18 I go use war, honga and diziz take porshu dem, sotey all di oda nashons for di world go shok, fear, laf and curse dem for anywhere wey I skata dem go,
JER 29:19 bikos dem nor gri hear my word wey I dey always send go give dem thru my profets.
JER 29:20 All of una wey I send go Babilon as prisonas, make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.’
JER 29:21 “Dis na wetin Israel God wey dey mighty tok about Ahab wey bi Kolaya pikin and Zedekaya wey Maaseaya born, wey dey lie for una with God name. God sey, ‘I don give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and e go kill dem for una present.’
JER 29:22 So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’
JER 29:23 Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.”
JER 29:24 Israel God tell Jeremaya, “Make yu go tell Shemaya wey kom from Nehelam
JER 29:25 sey di Oga wey bi Israel God wey dey rule di nashons get message for am. Tell am sey, ‘Just as yor mind tell yu, na so too yu send leta go give Zefanaya di priest wey Maaseaya born; di oda priests and all di pipol wey dey Jerusalem.’ For yor leta, yu tell Zefanaya sey,
JER 29:26 ‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun.
JER 29:27 But why yu neva do am to Jeremaya for Anatot, wey dey tell pipol sey e bi profet?
JER 29:28 Bikos Jeremaya tell di pipol wey dey Babilon sey, dem go stay as prisonas for long time, so make dem build house, setol down, plant and chop anytin wey dem plant.’ ”
JER 29:29 Zefanaya di priest kon read di leta give Profet Jeremaya.
JER 29:30 Den God tell Jeremaya sey,
JER 29:31 “Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.
JER 29:32 Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol.
JER 30:1 Na Israel God wey dey mighty
JER 30:2 tell mi sey: “Make yu rite evritin wey I tell yu put for one book,
JER 30:3 bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again.
JER 30:4 God tell Israel and Judah pipol:
JER 30:5 “I dey hear as una dey kry, bikos of una fear and di wahala wey una dey face.
JER 30:6 Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?
JER 30:7 Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”
JER 30:8 God sey: “Wen dat day go kom, I go remove di load wey dey dia neck kon break di shain and dem nor go bi slave to strenjas again.
JER 30:9 Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.
JER 30:10 My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.
JER 30:11 I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment.
JER 30:12 God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.
JER 30:13 Nobody go kare for una or cure una sore; una nor get hope at-all.
JER 30:14 Doz wey love una, don forget una; dem nor kare about una again, bikos I don attack una like una enemy. Una ponishment go sirious well-well, bikos una wiked and don sin well-well.
JER 30:15 Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.
JER 30:16 But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.
JER 30:17 And even doh una enemies sey, ‘Zion nor mean anytin and nobody kare about am,’ I go make una well again kon heal una wound.
JER 30:18 God sey, “I go bring my pipol kom back to dia land kon sorry for dem. Dem go build Jerusalem again and di king palis go dey as e bi before.
JER 30:19 Di pipol wey dey stay der go sing, praiz and dem go shaut for joy. My blessing go make dem many well-well and e go bring honor for dem.
JER 30:20 Dia shidren-shidren go bi as dem bi before and dem go always dey my present, den I go ponish di pipol wey bin dey opress dem.
JER 30:21 Dia leaders go kom from dia own nashon and dia prince go bi dia own pipol. E go kom meet mi wen I invite am, bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.
JER 30:22 Dem go bi my pipol and I go bi dia God.
JER 30:23 God vexnashon go kom like heavy breeze! Like strong breeze wey go blow wiked pipol head komot.
JER 30:24 En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.
JER 31:1 God sey, “For dat time, all di tribe wey dey Israel, na mi go bi dia God and dem go bi my pipol.
JER 31:2 Doz wey still dey alive, I go sorry and favor dem wen dem dey desert. I go give Israel pipol peace for dia mind.
JER 31:3 I go kom help dem, bikos I love Israel pipol well-well and na dis make mi still dey show dem my love wey nor dey end.
JER 31:4 I go build una again and una go take una sheke-sheke kon dance and dey happy again.
JER 31:5 Una go plant vineyard on-top Samaria hill again and di pipol wey plant dem, go chop from dem.
JER 31:6 Yes, di time dey kom wen doz wey dey guide di gate go koll from Efraim hill sey, ‘Kom make wi go Zion go woship di Oga wey bi awa God.’ ”
JER 31:7 God even sey, “Make una sing and happy for Israel pipol; make una happy for di nashon wey great well-well. Make dem hear una praiz for evriwhere kon sey, ‘God, make Yu save yor pipol, diliver Israel pipol wey remain.’
JER 31:8 Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.
JER 31:9 As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”
JER 31:10 All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok, den una go-go tok about am for far land wey dey near di sea sey, “Just as shepad dey guide en sheep, na so too God wey skata en pipol, go gada and guide dem again.
JER 31:11 God go free and save Israel pipol from strong nashons wey dey opress dem.
JER 31:12 Bikos of di gift wey God give dem wey bi; korn, wine, olive oil, sheep and melu, dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion. Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well kon get evritin wey dem wont.
JER 31:13 Den di yong wimen go sing with joy, while di yong and old men, go dey happy. I go konfort dem kon turn dia kry to joy and dia sorrow go bi happiness.
JER 31:14 I go give good food to dia priests and my pipol go get evritin wey dem wont.
JER 31:15 God sey, “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”
JER 31:16 But naw, dis na wetin God dey tok, “Make yu nor kry again, bikos I go reward yu. Yu shidren go kom back from dia enemies land kom meet yu.
JER 31:17 True-true, yu get hope about yor tumoro and yor shidren go kom house back.
JER 31:18 I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.
JER 31:19 Before, wi sin against Yu, but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu. Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again. Di sin wey wi sin wen wi dey yong, dey make us dey shame.”
JER 31:20 So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.
JER 31:21 So make una mark di road, so dat una go know where una pass wen dem dey karry una go Babilon. Israel pipol, make una kom back to di town wey una run leave.
JER 31:22 Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time? Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart and e go dey special like wen woman dey protet man.”
JER 31:23 Israel God wey dey rule evribody sey, “Wen I don bring di pipol kom back to dia land, dem go tok for Judah sey, ‘Make God bless Jerusalem hill; di holy place wey E dey stay.’
JER 31:24 Pipol go stay for Judah and all en towns; farmers go dey evriwhere and shepad go dey to guide dia animals.
JER 31:25 Doz wey don taya, I go give dem wota drink kon feed doz wey don weak bikos of honga.
JER 31:26 Den pipol go sey, ‘Wi sleep in peace and wake-up in peace.’ ”
JER 31:27 God sey, “Di time dey kom wen I go make pipol and animals full Israel and Judah land again.
JER 31:28 And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.
JER 31:29 “Wen dat time rish, pipol nor go sey, ‘Papa and mama chop grape wey nor ripe, but na dia shidren tit dey pain dem.’
JER 31:30 Instead, di pesin wey chop grape wey nor ripe, na en own tit go dey pain am and e go die bikos of en own sin.”
JER 31:31 God sey, “Di time dey kom wen I go make new kovenant with Israel and Judah pipol.
JER 31:32 E nor go bi like di old kovenant wey I make with dia grand-grand papa, wen I karry dem komot from Egypt. Even doh I bi like dia husband, dem nor gri keep di kovenant wey wi make.
JER 31:33 Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
JER 31:34 “Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before.
JER 31:35 God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”
JER 31:36 God promise sey, “As long as di world dey, na so too, Israel go bi my nashon forever.”
JER 31:37 Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do.
JER 31:38 God sey, “Di time dey kom wen dem go ribuild evriwhere for Jerusalem wey bi my town; from Hananel Towa for west go rish Korna Gate.
JER 31:39 And di boundary go kontinue from west go rish Gareb Hill kon turn go Goah.
JER 31:40 All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”
JER 32:1 God tok to mi for di tent year wey Zedekaya bi king for Judah and dat na di eighteent year wey Nebukadnezzar dey rule Babilon.
JER 32:2 For dat time, Babilon sojas attack Jerusalem and dem kon lock mi for di kourtyard wey dey di royal palis.
JER 32:3 King Zedekaya put mi for prison, bikos I tell am sey, “God sey, ‘I go allow Babilon king seize dis town
JER 32:4 and yu, King Zedekaya, nor go eskape. Dem go give Zedekaya to Babilon king and both of dem go tok face-to-face.
JER 32:5 Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win.
JER 32:6 Jeremaya sey, “God tell mi sey
JER 32:7 Hanamel wey bi yor papa broda Shallum pikin, go kom meet yu. So make yu buy en field wey dey for Anatot, for Benjamin land, bikos yu bi en klose relashon and yu get rite to buy am.
JER 32:8 So, Hanamel kom meet mi for di kourtyard sey make I buy en field, just as God tok. Den, I kon know sey, God really tok to mi.
JER 32:9 So I buy di field from Hanamel kon pay am seventeen pieces for silva.
JER 32:10 I sign and pipol witness evritin wey wi do, den I weigh di money for skale for am.
JER 32:11 I take di two paper wey wi sign as agriment (dem kontain di kontract and di kondishon)
JER 32:12 kon gi-am to Baruk wey Mahseaya pikin Neraya born. I give dem to am for Hanamel, di witness wey sign di agriment and all Jew pipol wey sidan for di kourtyard, present.
JER 32:13 I tell Baruk for dia present sey,
JER 32:14 ‘Israel God wey dey mighty don orda sey, “Make yu take di two paper kon put dem inside klay pot, so dat dem go dey save.”
JER 32:15 Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’
JER 32:16 “Afta I don give Baruk di agriment paper wey I take buy di land, I kon pray,
JER 32:17 ‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!
JER 32:18 Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.
JER 32:19 Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.
JER 32:20 Yu do strong and wonderful tins for Egypt and Yu still dey do dem till naw, both for Israel and for all di nashon and naw, dem don know Yu for evriwhere.
JER 32:21 Yu use yor mighty pawa and great strent take do mirakles and wonders wey make fear katch awa enemies. Na like dis Yu take bring yor pipol, Israel kom back from Egypt land.
JER 32:22 Yu give dem di rish and betta land wey Yu promise dia grand-grand papa.
JER 32:23 But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.
JER 32:24 Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.
JER 32:25 Even doh Yu know sey Babilon pipol won seize di land, na Yu my Oga God, still orda sey make I go buy di field and do di agriment for pipol present.’
JER 32:26 “Den God ansa mi,
JER 32:27 ‘Na mi bi di Oga wey bi evribody God. Nor-tin too hard for mi to do.
JER 32:28 So, mi wey bi God sey, “I go give dis town to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas and dem go seize
JER 32:29 and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.
JER 32:30 Dis tin go happen, bikos from di biginnin kon rish naw, Israel and Judah pipol don disobey and make mi vex, bikos of wetin dem do.
JER 32:31 E go happen bikos since dem build dis town kon rish naw, di pipol for dis town don make mi vex well-well, so I go distroy am.
JER 32:32 I go must do am, bikos of di bad-bad tins wey Judah and Jerusalem pipol don do. Bikos of di wiked tins wey dem do, I go distroy am with both dia king, leaders, priests and profets.
JER 32:33 Instead of dem to obey mi, dem turn dia back give mi. And even as I dey try to tish dem rish, dem nor gri learn or listin.
JER 32:34 Dem even go put dia yeye juju for di temple wey dem build to woship mi and naw, dem don make am dirty.
JER 32:35 Dem build altar for Baal juju for Ben-Hinnom Valley where dem for dey sakrifice dia shidren give Molek god. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.”
JER 32:36 “ ‘Jeremaya! Yu and di pipol korrect wen una sey war, honga and diziz go make dis town fall and Babilon king go seize am. Naw, make yu listin to wetin I get to tok about dis town:
JER 32:37 “I go gada all my pipol from di kountry where I skata dem put, bikos I bin dey vex and I go bring dem back to dis land, so dat dem go dey save.
JER 32:38 Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God.
JER 32:39 Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.
JER 32:40 I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
JER 32:41 I go happy to do good tins for dem and I go plant dem for dis land forever.
JER 32:42 “ ‘ “Just as I bring dis wahala for dem, na so too I go give dem all di good tins wey I don promise dem.
JER 32:43 Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.
JER 32:44 Pipol go buy dia land and dem go sign di agriment, gum-am and pipol go witness am. Dis tins go happen for Benjamin land; di village wey dey round Jerusalem; all Judah town and for di towns wey dey di kountries for hill with all di land under di hill for Judah sout. I go bring di pipol kom back to dia land.
JER 33:1 Wen I still dey prison for di kourtyard, God tok to mi again.
JER 33:2 Na mi, God do dis tins! Na mi God, make di eart kon put am for where e dey so. Dem know mi as Oga God; naw I dey tell yu,
JER 33:3 “Koll mi wen yu dey pray and I go ansa yu; I go tell yu great and wonderful tins wey yu nor know about.
JER 33:4 Mi, di Oga wey bi Israel God sey, war and wahala go skata all di house for Jerusalem and di royal palis for Judah.
JER 33:5 Una won go fight Babilon pipol, but una sojas nor betta pass doz wey don die, bikos as I dey vex, I don make up my mind to distroy dem. I don turn from dem, bikos of dia wikedness.
JER 33:6 But I go heal di town and en pipol kon make dem well again. I go give dem peace forever and dem go dey save.
JER 33:7 I go make Israel and Judah pipol prosper and I go build dem as dem bi before.
JER 33:8 I go forgive dem dia sin. Yes! I go forgive dem all di sin wey make dem go against my kommand.
JER 33:9 Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”
JER 33:10 God sey, “Una dey sey, ‘Dis place bi like desert, bikos pipol or animals nor dey stay inside again.’ Una korrect; bikos Judah town and all di street for Jerusalem go dey empty; pipol or animal nor go stay der, but una go hear pipol dey shaut dey happy for dis place again.
JER 33:11 Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before.
JER 33:12 God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.
JER 33:13 Shepad go kount dia sheep again for all di towns wey dey di hill kountry; di valley; Judah sout; Benjamin land; di village wey round Jerusalem and all di town for Judah.
JER 33:14 God sey, “Di time dey kom wen I go do wetin I promise Israel and Judah pipol.
JER 33:15 For dat time, I go choose king wey dey raitious from David shidren-shidren. “Di king go do wetin dey korrect and good for evriwhere for di land.
JER 33:16 As e dey rule, Judah pipol go dey save, while Jerusalem pipol go stay for peace. For dat time, dem go koll Jerusalem town, ‘God Don Save Us.’
JER 33:17 Mi wey bi God, promise sey na only David shidren-shidren go always bi king for Israel
JER 33:18 and na from only Levi tribe priest go for always kom and serve, offa burnt ofrin, korn ofrin and sakrifice for mi.”
JER 33:19 God tell mi,
JER 33:20 “If yu fit break di kovenant wey I make with nite and day, so dat dem nor go kom out again for di korrect time,
JER 33:21 den yu go still fit break di kovenant wey I make with my savant David and Levi tribe wey sey, ‘Kings go always kom from David family and na Levi family go always bi priests.’
JER 33:22 I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”
JER 33:23 God still tell mi sey,
JER 33:24 “Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.
JER 33:25 But mi wey bi God don make kovenant with di nite and day and I don make di law wey dey kontrol di heaven and eart.
JER 33:26 Since I don do dis tin, I go keep my kovenant with my savant Jakob and David shidren-shidren. I go choose one of David shidren-shidren make e rule ova Abraham, Isaak and Jakob shidren-shidren. I go sorry for my pipol kon make dem prosper again.”
JER 34:1 Wen King Nebukadnezzar for Babilon, en sojas with oda sojas from di kingdoms wey e dey rule, attack Jerusalem and Judah, God kon tok to mi.
JER 34:2 Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.
JER 34:3 Yu nor go fit eskape and dem go katch yu give di king. Yu go si and tok to am one-on-one, den dem go take yu go Babilon.
JER 34:4 Zedekaya, make yu listin to wetin I dey tok about yu. Dem nor go kill yu for war and
JER 34:5 yu go die for peace. Just as pipol burn incense wen dem beri yor grand-grand papa wey bi king before yu, na so too dem go burn incense for yu. Dem go mourn for yu kon sey, “Awa king don die!”
JER 34:6 Den I kon go tell King Zedekaya dis message for Jerusalem
JER 34:7 and dat time, Babilon king and en sojas dey attack di town. Di sojas still attack Lakish and Azeka, di only oda strong town wey remain for Judah.
JER 34:8 God tok to mi afta King Zedekaya and Jerusalem pipol don make agriment sey make dem free
JER 34:9 dia Hibru slaves, both man and woman, so dat nobody go use en own broda or sista as slave again.
JER 34:10 So all di pipol and dia leaders kon gri to free dia slave and nor sofa dem again.
JER 34:11 But afta, dem shange dia mind kon force dem to work as slave again.
JER 34:12 Den di Oga wey bi
JER 34:13 Israel God tell mi sey make I tell di pipol: “I make kovenant with una grand-grand papa wen I take dem komot from Egypt kon free dem from dia sofa. I tell dem sey,
JER 34:14 ‘For di sevent year, dem must free any Hibru pesin wey don serve dem for six years.’ But una grand-grand papa nor gri hear or listin to wetin I tok.
JER 34:15 Una bin shange kon dey do wetin I wont. All of una gri to free una slave and una enter kovenant for my present; for di temple where dem for dey woship mi.
JER 34:16 But naw, una don shange again and una nor gri respet mi. All of una don take di slave wey una don free before back kon force dem to serve una again.
JER 34:17 “Naw, mi wey bi God sey, ‘Una don disobey mi; una nor gri free una brodas and sistas. Since na like dat, I go free una so dat war, honga and diziz, go kill una. I go make evry nashon for di world fear for wetin I go do to una.
JER 34:18 I go ponish doz wey break di kovenant wey dem make with mi kon make dem bi like melu wey dem divide into two kon waka pass di centre. I go do am bikos dem nor gri keep di agriment wey dem make for my present.
JER 34:19 I go ponish Judah and Jerusalem leaders, ofisas, priests and all di pipol for di land wey make di kovenant with mi.
JER 34:20 I go make dia enemies katch and kill dem, den birds and wiked animals go chop dia dead body.
JER 34:21 I go still give King Zedekaya and en ofisas to pipol wey won kill dem. I go make Babilon sojas katch dem, even doh dem don stop di fight for naw.
JER 34:22 Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”
JER 35:1 Wen Josaya pikin Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi,
JER 35:2 “Make yu go Rekab town go tok to di pipol, den make yu bring dem kom one of di room for di temple kon give dem wine drink.”
JER 35:3 So I go meet Jaazanaya (anoda Jeremaya pikin and Habazzinah grand-pikin) and en brodas with en shidren, plus evribody wey dey Rekab town kon take dem
JER 35:4 enter di temple. I take dem enter di room where Igdalaya pikin, Profet Hanan disciples dey stay. Di room dey near where di offisa for di temple dey stay and Maaseaya wey Shallum born, wey dey guide di temple, dey stay for di room wey dey up, inside di temple.
JER 35:5 Den I put cup and basin wey wine full for Rekab pipol front kon tell dem, “Make una take wine drink.”
JER 35:6 But dem ansa, “Wi nor dey drink wine, bikos awa grand-grand papa Jehonadab wey Rekab born tell us sey, make wi nor ever drink wine.”
JER 35:7 E still tell us sey, make wi nor build house, plant anytin or buy any vineyard for awasef. E kommand us sey make wi dey stay for tent, so dat wi go fit stay for dis land wey wi dey stay like strenjas.
JER 35:8 “So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;
JER 35:9 build house for awasef; get vineyard or plant.
JER 35:10 Na tent wi dey stay and wi dey obey evritin wey Jehonadab awa grand-grand papa, kommand us.
JER 35:11 But wen King Nebukadnezzar for Babilon skata di land, wi sey make wi kom Jerusalem, so dat wi go fit eskape from Babilon and Siria sojas. Na dis make wi dey stay for Jerusalem naw.”
JER 35:12 Den Israel God wey dey mighty
JER 35:13 sey make I go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “Mi wey bi God, dey ask una wetin make una nor gri listin to mi kon obey evritin wey I kommand.
JER 35:14 But Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand, wen e sey make dem nor drink wine. And until naw, dem neva drink wine. Even doh I dey always tok to una, una nor gri obey mi.
JER 35:15 I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.
JER 35:16 Yes, Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand dem, but una nor gri obey mi.
JER 35:17 So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”
JER 35:18 Den I tell Rekab pipol: “Israel God wey dey mighty sey, ‘Una don obey evritin wey una grand-grand papa Jehonadab tell una; dey follow evritin wey e tish una and una don do evritin wey e kommand una.’ ”
JER 35:19 So mi, wey bi Israel God promise sey, “Jehonadab wey bi Rekab pikin, go always get one of en sons wey go serve mi.”
JER 36:1 For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi:
JER 36:2 “Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.
JER 36:3 May bi, if Judah pipol hear di way I won take distroy dem, dem go shange from all di bad-bad tins wey dem dey do, den I go forgive all dia sin and wikedness.”
JER 36:4 So, I koll Baruk wey bi Neraya pikin kon tell am evritin wey God tell mi and Baruk rite evritin put for one book.
JER 36:5 Den I tell Baruk, “Dem sey make I nor enter di temple again.
JER 36:6 So I wont make yu go der wen di pipol dey fast again, den read wetin I tell yu sey God tok, wey yu rite for dis book, so dat all of dem go hear am.
JER 36:7 May bi, den dem go pray give God kon shange from di bad tins wey dem dey do, bikos God don treaten dem with en vexnashon and fire.”
JER 36:8 So Baruk read God word for di temple, just as I tell am sey make e do.
JER 36:9 For di ninet mont for di fift year wey Jehoiakim bi king for Judah, all di pipol wey dey Jerusalem and di pipol wey kom Jerusalem from Judah, kom fast for God temple.
JER 36:10 For dat time, Baruk enter di temple kon stand for di gate wey bi Shafan pikin, Gemaraya di royal seketry room. Di room dey di Uppa Kourt near di New Gate. Den e read from di book, evritin wey I tok, so dat dem go hear am.
JER 36:11 Mikaya wey Shafan pikin Gemaraya born, hear wen Baruk dey read wetin God tok.
JER 36:12 So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.
JER 36:13 Den Mikaya tell dem evritin wey e hear Baruk dey read give di pipol.
JER 36:14 So di ofisas kon send Jehudi wey Shelemaya pikin Netanaya born and na Kushi born Shelemaya. Dem sey make e go tell Baruk make e bring di book wey e from read give di pipol. So Baruk karry di book go meet dem.
JER 36:15 Dem tell am, “Make yu sidan and read wetin dey di book for us.” So Baruk read am give dem.
JER 36:16 Afta e read finish, dem look demsef kon dey sopraiz, so dem tell Baruk, “Wi must go tell di king about all dis tins.”
JER 36:17 Den dem ask am, “Tell us, how yu take rite dis tins, na Jeremaya tell yu?”
JER 36:18 Baruk ansa, “Na Jeremaya tell mi evritin wey I rite with ink for dis book.”
JER 36:19 Den dem tell am, “Yu and Jeremaya must go hide and make una nor let anybody know where una dey.”
JER 36:20 Di ofisas put di book for Elishama, di kourt seketry room, den kon go tell di king evritin wey Baruk tok.
JER 36:21 Den di king tell Jehudi, “Make yu bring di book kom.” So, Jehudi go bring di book kom from Elishama room kon read am give di king and en ofisas wey stand round am.
JER 36:22 Dat time, na rainin sizin, so di king sidan for front of fire for en palis.
JER 36:23 As Jehudi read three or four line finish, di king vex, kut dat part for di book komot with knife kon trow am for di fire. Na so e do until e burn di whole book finish.
JER 36:24 But even as di king and all en ofisas hear evritin, dem nor still fear or turn from sin kom meet God.
JER 36:25 Even doh Elnatan, Delaaya and Gemaraya beg di king sey make e nor burn di book, e nor listin to dem.
JER 36:26 Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
JER 36:27 Afta King Jehoiakim don burn di book wey I tell Baruk make e rite, God kon tell mi
JER 36:28 sey make I take anoda book, rite evritin wey dey di first one wey King Jehoiakim burn.
JER 36:29 God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’
JER 36:30 But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.
JER 36:31 I go ponish yu, yor shidren-shidren and all yor ofisas, bikos of di sin wey all of una kommit. Yu or Jerusalem and Judah pipol nor gri listin to my warnin. So I go bring di wahala wey I bin tell una about, kom.’ ”
JER 36:32 So, I take anoda book kon gi-am to my seketry, Baruk and e rite evritin wey I tell am. E rite evritin wey dey di first won kon add some oda ones wey I sey make e rite, join am.
JER 37:1 King Nebukadnezzar for Babilon kon put Zedekaya wey bi Josaya pikin, as king for Judah, instead of Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin.
JER 37:2 But King Zedekaya, en ofisas and di pipol nor gri obey di message wey God send mi.
JER 37:3 So King Zedekaya send Jehucal wey Shelemaya born and Priest Zefanaya wey bi Maaseaya pikin sey make dem kom tell mi make I pray make God kom help awa pipol.
JER 37:4 By dat time, dem neva put mi for prison and I still dey free to waka as I like for di town.
JER 37:5 For dat time, Babilon sojas surround Jerusalem, but wen dem hear sey Egypt pipol don cross dia boundary dey kom, dem kon go back.
JER 37:6 Den Israel God tell mi,
JER 37:7 “Make yu tell Zedekaya wey sey make yu pray make I help dem sey, ‘Egypt sojas wey bin dey kom help yu, go-go back to dia town wen dem don help yu finish.’
JER 37:8 But leta, Babilon pipol go kom back kon attack, seize and burn dis town rish groun.
JER 37:9 So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.
JER 37:10 Even if una kill Babilon sojas well-well and na only di men wey una wound remain, dem go still kom burn dis town rish groun.”
JER 37:11 Dis na wetin happen wen Babilon sojas leave Jerusalem, bikos Egypt sojas dey kom.
JER 37:12 From Jerusalem, I kon go Benjamin town, so dat I go get my own part for awa family propaty.
JER 37:13 But wen I rish Benjamin Gate, Irijah wey Hananaya pikin Shelemaya born wey bi di guards oga kon stop mi dey sey, “Na Babilon sojas send yu kom spy dis land!”
JER 37:14 So I ansa, “No o-o! I nor dey spy for Babilon sojas o-o.” But Irijah nor gri listin to mi, so e arrest mi kon take mi go meet di ofisas.
JER 37:15 Dem vex for mi well-well kon orda sey make dem beat and lock mi for Jonatan, di kourt seketry house wey dem turn to prison.
JER 37:16 Dem put mi for undagroun prison and I tey well-well for der.
JER 37:17 Afta, King Zedekaya sey make dem koll mi kom, den e take mi go korna kon ask, “God give yu any message for us?” I ansa, “Yes! E give mi.” Den I sey, “Babilon king go kom katch and karry yu go.”
JER 37:18 Den I ask am, “Wish crime I kommit against yu, yor ofisas and di pipol, wey make una put mi for prison?
JER 37:19 Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?
JER 37:20 But naw my oga, make yu listin to mi kon do evritin wey I dey beg yu. Make yu nor let mi go back to dat prison wey dey Jonatan house. Bikos if yu send mi go back, I go die for der.”
JER 37:21 So, King Zedekaya kon sey make dem lock mi for di kourtyard wey dey di palis. I stay for der and evriday, dem dey give mi bread chop, until all di bread for di town finish.
JER 38:1 Shefataya wey bi Mattan pikin; Gedalaya wey Pashhur born; Jehucal wey bi Shelemaya pikin and Pashhur wey Malkijah born kon hear wen I dey tell di pipol sey,
JER 38:2 “God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
JER 38:3 Dem still hear wen I sey, “God sey, ‘I go give Babilon sojas dis town and dem go seize am.’ ”
JER 38:4 Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
JER 38:5 King Zedekaya ansa, “No wahala, make una do am anytin wey una like and I nor go stop una.”
JER 38:6 So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
JER 38:7 Ebed Melek, one Ethiopia man wey dey work for di palis, hear sey dem put mi for di well. And by dat time, di king get kase wey e won judge for Benjamin Gate.
JER 38:8 So Ebed Melek go der go tell di king,
JER 38:9 “My oga, wetin dis men do so, nor good o-o. Dem don put Jeremaya inside well, where dem know sey honga go kill-am, bikos food nor dey di town.”
JER 38:10 Den di king sey make Ebed Melek take thirty men follow body, so dat dem go-go bring mi kom out from di well before I go die for der.
JER 38:11 So Ebed Melek and di men kon go di store where dem dey keep tins for di palis kon kollect old klot, tie am join rope kon trow am give mi.
JER 38:12 E sey make I put di klot for under my armpit, so dat di rope nor go wound mi. So I do as e tok,
JER 38:13 den dem drag mi kom out kon take mi go di kourtyard.
JER 38:14 One day, King Zedekaya sey make dem bring mi kom meet am for di third gate wey dem dey pass enter di temple, den e sey, “I won ask yu kweshon and I wont make yu tell mi di whole trut.”
JER 38:15 But I ansa, “If I tell yu di trut, yu go kill mi and if I advise yu, yu nor go listin.”
JER 38:16 So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”
JER 38:17 Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.
JER 38:18 But if yu nor surenda, Babilon pipol go take dis land; dem go burn di town rish groun and yu nor go fit eskape from dem.’ ”
JER 38:19 But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”
JER 38:20 So I kon tell am, “E nor go give yu to dem. I dey beg yu make yu listin to God message, den evritin go-go well for yu and dem nor go kill yu.
JER 38:21 But if yu nor gri surenda, dis na wetin God show mi sey go happen:
JER 38:22 ‘For di vishon, I si sey, dem karry all di wimen wey remain for Judah royal palis go meet Babilon ofisas and dis na wetin dem dey tell di king: “ ‘ “Na yor best friends give yu wrong advise, dem dey kontrol yu and naw wey yu don enter trobol, all of dem don run leave yu.” ’ ”
JER 38:23 Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”
JER 38:24 Zedekaya kon sey, “Nor let anybody know wetin wi tok so, if not yu go die.
JER 38:25 If di ofisas hear sey I tok to yu, dem go kom ask yu wetin wi tok. Dem go promise yu sey dem nor go kill yu if yu tell dem evritin wey wi tok.
JER 38:26 But just tell dem sey yu dey beg mi make I nor send yu go back to prison, so dat yu nor go die for der.”
JER 38:27 So all di ofisas kom kweshon mi and I tell dem wetin di king sey make I tok. Nor-tin dem fit do, bikos anoda pesin nor hear wetin wi tok.
JER 38:28 So I dey di palis kourtyard, until di day wey dem attack and karry Jerusalem pipol go Babilon.
JER 39:1 For di tent mont inside di ninet year wen Zedekaya bi king for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kom attack Jerusalem with en sojas.
JER 39:2 Babilon sojas break enter Jerusalem for di ninet day for di fourt mont wen Zedekaya don dey rule for eleven years.
JER 39:3 Wen dem attack Jerusalem, Babilon sojas go pozishon demsef for di Middle Gate and Nergal-Sharezer wey kom from Samgar, Sarsechim and anoda Nergal-Sharezer wey bi senior ofisas dey among dem too.
JER 39:4 Wen King Zedekaya and all en sojas si wetin dey happen, dem kon try to run komot for di town for nite. Dem pass di gate wey join di two wall for back near di king gardin kon go Jordan River Valley.
JER 39:5 But Babilon sojas porshu dem kon katch Zedekaya near Jeriko. Den dem take am go meet King Nebukadnezzar for Riblah town wey dey Hamat land and na for der Nebukadnezzar for judge am.
JER 39:6 Dem force Zedekaya make e dey look as dem dey kill all en shidren and en ofisas for Riblah.
JER 39:7 Afta dat one, dem blind Zedekaya eye kon tie am with shain, den dem karry am go Babilon.
JER 39:8 By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.
JER 39:9 Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.
JER 39:10 But e leave some poor pipol kon give dem vineyard and farm, so dat dem go dey work for der.
JER 39:11 But King Nebukadnezzar kommand Nebuzaradan wey bi di sojas oga sey make e go find Jeremaya kom.
JER 39:12 E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.”
JER 39:13 So Nebuzaradan, with some big ofisas wey bi Nebushazban, Nergal-Sharezer with all di oda Babilon king offisa
JER 39:14 kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.
JER 39:15 Wen I still dey prison for di palis, God tell mi
JER 39:16 sey make I tell Ebed Melek wey kom from Ethiopia sey, “Israel God wey dey mighty sey, ‘Just as I promise, I go distroy dis town and nor-tin go remain.’ And yu go si am wen e dey happen.
JER 39:17 But mi, wey bi God go protet yu from di pipol wey yu dey fear.
JER 39:18 I go save yu and dem nor go kill yu. Yu go eskape with yor life, bikos yu trust mi.
JER 40:1 God tok to mi afta Nebuzaradan, wey bi di sojas oga don free mi for Rama. Na shain dem bin take dey karry mi as prisona go Babilon with all di oda pipol from Jerusalem and Judah.
JER 40:2 Di sojas oga take mi go one side kon tell mi, “Di Oga wey bi yor God sey, E go distroy dis land
JER 40:3 and naw, E don do wetin E sey E go do. All dis tin happen, bikos yor pipol sin and nor gri obey God.
JER 40:4 But naw, I dey take di shain komot from yor hand kon free yu. If yu like follow mi go Babilon, no problem! I go kare for yu for der. But if yu nor won go, yu fit choose anywhere wey yu wont, den make yu go der.”
JER 40:5 Wen I nor ansa, Nebuzaradan kon sey, “Make yu go back go meet Gedalaya wey Shafan pikin, Ahikam born, bikos na-im Babilon king don choose as rulers for Judah. Yu fit stay with en and di pipol or yu fit still go anywhere wey yu like to go.” Den e give mi gift and some food kon sey make I dey go.
JER 40:6 Gedalaya wey bi Ahikam pikin, I go stay en house for Mizpa kon dey with my pipol wey remain for di town.
JER 40:7 Some among Jew ofisas and dia sojas still hide for di kountry for di hill. Wen dem hear sey Babilon king don make Gedalaya wey bi Ahikam pikin govnor for di land ova di men, wimen, shidren and doz poor pipol wey dem nor karry go Babilon as prisonas,
JER 40:8 Ishmael wey Netanaya born; Johanan wey bi Kareah pikin; Seraya wey Efai pikin Tanhumet born wey still kom from Netofat; with Jezanaya wey kom from Maaka kon go meet Gedalaya for Mizpa with dia men.
JER 40:9 Gedalaya tell dem, “I dey tell una naw sey, make una nor fear to surenda give Babilon pipol. Make una stay for dis land, serve Babilon king and evritin go-go well for una.
JER 40:10 Mi too, go stay for Mizpa to tok for una wen Babilon pipol kom here. Una fit gada and store wine, fruit and olive oil kon stay for di village wey una don choose.”
JER 40:11 By dat time, Israel pipol wey dey Moab, Ammon, Edom and oda kountry hear sey Babilon king allow some Israel pipol stay for Judah and e don make Gedalaya dia govnor.
JER 40:12 So dem komot from where dem dey kon go stay Judah. Dem kom meet Gedalaya for Mizpa and dem harvest many wine and fruit for der.
JER 40:13 Afta, Johanan and di sojas oga wey hide before, go meet Gedalaya for Mizpa,
JER 40:14 e kon tell am, “Yu nor know sey, ‘King Baalis for Ammon don send Ishmael make e kom kill yu?’ ” But Gedalaya nor bilive dem.
JER 40:15 Den Johanan koll am go korna kon sey, “Make I go kill Ishmael and nobody go know who do am. If not, e go kill yu and dat kind tin go skata Jew pipol wey gada round yu and e go kause wahala for evribody wey remain for Judah.”
JER 40:16 But Gedalaya ansa, “Make yu nor do am! Bikos wetin yu dey tok about Ishmael so, na lie!”
JER 41:1 For di sevent mont for dat same year, Ishmael wey Elishama pikin, Netanaya born, wey still bi memba for di royal family and one of di king main offisa kon go meet Gedalaya for Mizpa and e karry ten men follow body. Wen all of dem dey chop togeda,
JER 41:2 Ishmael and di ten men, bring dia swod out kon kill Gedalaya wey Babilon king put as govnor for Judah.
JER 41:3 Ishmael still kill Israel pipol and Babilon sojas wey follow Gedalaya dey for Mizpa.
JER 41:4 Di next day, before anybody know sey Gedalaya don die,
JER 41:5 eight men kom from Shekem, Shiloh and Samaria. Dem don skrape dia hair, tear dia klot kon kut demsef to show sey dem dey mourn and dem karry korn and incense go offa for di temple.
JER 41:6 So Ishmael kry komot for Mizpa go meet dem. Wen e si dem, e kon sey, “Abeg! Make una kom si wetin happen to Gedalaya!”
JER 41:7 But as dem just enter di town, Ishmael and en men kill dem kon trow dia body put for well.
JER 41:8 But e get ten men for di group wey tell Ishmael sey, “Abeg! Make yu nor kill us! Wi get wheat, barley, olive oil and honey wey wi hide for farm.” So e nor kill doz ones.
JER 41:9 Di well wey Ishmael trow di men dead body put, na King Asa dig am wen King Baasha for Israel kom attack am. Naw, Ishmael don pak dead body full am.
JER 41:10 Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.
JER 41:11 But wen Johanan and di oda soja leaders hear wetin Ishmael do,
JER 41:12 dem kon porshu and katch Ishmael near di big pool wey dey Gibeon.
JER 41:13 Wen di pipol wey Ishmael katch as prisonas si Johanan and di oda sojas, dem kon dey happy.
JER 41:14 Dem turn kon run go meet Johanan, so dat e go help dem.
JER 41:15 But Ishmael and eight of en men run leave Johanan kon eskape go Ammon land.
JER 41:16 Den Johanan and di oda sojas oga karry all di pipol wey Ishmael katch as prisonas from Mizpa, afta e don kill Gedalaya.
JER 41:17 Dem take all of dem go Gerut Kimham village near Betlehem and dem from der go Egypt.
JER 41:18 Dem dey fear wetin Babilon pipol go do wen dem hear sey Ishmael kill Gedalaya, di govnor wey Babilon king choose. As dem dey go, dem kon stop for Kimham wey dey near Betlehem.
JER 42:1 Den all di sojas oga with Johanan wey bi Kareah pikin and Jezanaya wey Hoshaaya born kom with oda pipol
JER 42:2 kon tell mi: “Abeg, make yu do wetin wi won tell yu so! Make yu help us wey dey alive pray to di Oga awa God. Wi many before, but naw, yusef dey si sey wi nor many again.
JER 42:3 Make yu pray make di Oga awa God show us where wi go-go and wetin wi go do.”
JER 42:4 So, I ansa, “No wahala! I go pray to di Oga awa God just as una tok, den I go tell una anytin wey E tok! I nor go hide anytin from una!”
JER 42:5 Den dem tell mi, “Make God wey dey tok true and dey faithful, bi awa witness if wi nor do wetin E sey make yu tell us.
JER 42:6 Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”
JER 42:7 Afta ten days, God tok to mi,
JER 42:8 so I kon koll Johanan, di sojas offisa, doz wey dey with am and di oda pipol.
JER 42:9 I tell dem, “Di Oga wey bi Israel God wey una sey make I pray give, dis na wetin E tok:
JER 42:10 ‘If una ready to stay for dis land, I go build una up and una nor go skata again; I go plant una and nor-tin go fit rut una again. Na pains and sorrow full my heart, bikos of di wahala wey I kause for una.
JER 42:11 Make una nor fear Babilon king; I dey with una and I go save una from en pawa.
JER 42:12 I go show una mesi. So, I go make am sorry for una kon allow una go back to una own land.
JER 42:13 “But if una sey, ‘Wi nor won stay for dis land!’ Den una dey disobey di Oga una God.
JER 42:14 Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’
JER 42:15 If una wey remain for Judah do like dat, den make una hear wetin Israel God dey tok, ‘If una don gri sey una won go stay for Egypt,
JER 42:16 den di war wey una dey fear, go happen and honga go kill una for der.
JER 42:17 Na war, honga and diziz go kill all di pipol wey gri sey dem won go stay Egypt. No one among dem go survive or eskape di wahala wey I go bring for dem.’
JER 42:18 Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
JER 42:19 “I still tell dem, ‘God don tell una wey remain for Judah sey make una nor go Egypt.’ So I dey warn una,
JER 42:20 make una nor make big mistake. Na una sey make I pray give di Oga awa God and una promise sey una go do evritin wey E kommand.
JER 42:21 And naw, I don tell una, but una nor one gri do evritin wey God sey make I tell una.
JER 42:22 So make una remember sey; una go die for war and honga and diziz go kill una for di land wey una dey run go stay.”
JER 43:1 Wen I don tell di pipol evritin wey di Oga dia God sey make I tell dem,
JER 43:2 Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt.
JER 43:3 But na Baruk wey Neraya born, na-im sey make yu tell us dis kind lie, so dat Babilon pipol go kill or karry us go Babilon, bikos dem get pawa pass us.”
JER 43:4 So Johanan, di sojas offisa and di oda pipol nor gri stay for Judah, just as God kommand dem.
JER 43:5 Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt.
JER 43:6 Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body.
JER 43:7 Dem nor obey wetin God kommand and dem kon go Tahpanhes town for Egypt.
JER 43:8 God tok to mi for Tahpanhes sey,
JER 43:9 “Make yu take some big-big stone for Judah pipol front kon go beri dem for Fero house front for Tahpanhes.
JER 43:10 Den tell di pipol sey, ‘Mi wey bi Israel God wey dey mighty go bring my savant, King Nebukadnezzar for Babilon kom dis place and e go put en throne kon spread en royal tent on-top dis stone wey Jeremaya beri so.
JER 43:11 Nebukadnezzar go kom win Egypt. Di pipol wey I don sey diziz go kill, na diziz go kill dem; doz wey dem go karry go as prisonas, dem go karry dem go and doz wey dem go kill for war, go die for war.
JER 43:12 I go set fire for Egypt gods temple and Babilon pipol go burn dia gods or karry dem go. Just as shepad dey kill and remove all di lice wey dey en klot, na so too Babilon king go kill and remove Egypt pipol from dia land.
JER 43:13 E go distroy dia juju pila wey dey di Sun Temple with all di gods for Egypt; den e go burn dia temple rish groun.’ ”
JER 44:1 God tell mi about Israel pipol wey dey stay for Migdol, Tahpanhes, Memfis and all di oda towns wey dey Egypt sout.
JER 44:2 Israel God wey dey mighty sey, “Yu yorsef don si di way I take distroy Jerusalem and all di oda towns wey dey Judah. Dia town still skata and dem nor get hope again,
JER 44:3 bikos dem sin kon make mi vex. Dem offa sakrifice kon dey serve oda gods wey dem or yu or dia grand-grand papa nor ever woship.
JER 44:4 I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,
JER 44:5 but dem nor gri listin or hear mi. Dem still dey offa sakrifice give oda gods.
JER 44:6 Na dis make mi pour my fire and vexnashon for Judah towns and all di street for Jerusalem. As e bi naw, dia life don skata and pipol wey si dem, dey fear.
JER 44:7 “So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.
JER 44:8 Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!
JER 44:9 Una don forget all di wiked tins wey una grand-grand papa, Judah kings, dia wife, una and una wife do for Judah town and Jerusalem strits?
JER 44:10 But till naw, una neva gri honbol unasef. Una neva honor mi or live una life as I kommand una and una grand-grand papa.
JER 44:11 “ ‘Bikos of dis, mi wey bi Israel God, go turn against una kon distroy Judah.
JER 44:12 Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.
JER 44:13 I go ponish all di pipol wey dey Egypt, just as I take war, honga and diziz take ponish Jerusalem pipol.
JER 44:14 Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”
JER 44:15 Den all di men wey know sey dia wife dey offa sakrifice give oda gods and di wimen wey stand der with Israel pipol wey dey stay for Egypt sout, all of dem kon gada kom tell mi sey,
JER 44:16 “Wi nor go listin to wetin yu tell us sey na God tell yu.
JER 44:17 Instead, wi go do evritin wey won do. Wi go offa sakrifice give awa goddes wey bi Heaven Kween kon pour wine for am too, just as wi, awa grand-grand papa, awa king and leaders dey do for Judah towns and Jerusalem strits before. Dat time, wi get plenty food to chop; wi dey prosper and wi nor get wahala.
JER 44:18 But since wi stop to sakrifice and pour wine give Heaven Kween, wi nor get anytin again and war with honga don early kill awa pipol finish.”
JER 44:19 Di wimen still sey, “Before wi bake kake wey bi like Heaven Kween or offa sakrifice or gi-am wine, wi dey first tell awa husband and dem dey gri with evritin wey wi dey do.”
JER 44:20 Den I tell all di men and wimen wey ansa mi like dis sey,
JER 44:21 “Una tink sey God nor know sey una and una grand-grand papa with una kings, ofisas and all di pipol dey burn incense give juju for Judah town and all di street for Jerusalem?
JER 44:22 Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.
JER 44:23 All dis tins happen to una, bikos una offa sakrifice give oda gods kon sin against God wen una nor gri obey wetin E kommand.”
JER 44:24 Den I tell all di pipol, especially di wimen, “Wetin Israel God wey dey mighty tok about Judah pipol wey dey Egypt?
JER 44:25 Una and una wifes don promise Heaven Kween sey una go offa sakrifice kon gi-am wine and una don do as una tok. No problem at-all! Make una keep una word kon do wetin una promise!
JER 44:26 But naw, make una listin to di promise wey mi, God make with my strong name and dis promise na for Israel pipol wey dey Egypt: ‘I nor go ever let una use my name take make promise again or sey, “I swear with God wey get pawa!”
JER 44:27 I go make sure sey, una nor prosper and dem go distroy una finish. Diziz and war go kill una, until nobody go remain again.
JER 44:28 But some of una go eskape from Egypt kon go back to Judah. Den, doz wey survive go know wish pesin word happen. Weda na my own or dia own.
JER 44:29 Mi wey bi God go show una sign sey I go ponish una for dis place and as I promise sey I go distroy dis place, na so e go bi.
JER 44:30 Just as I give Zedekaya for Judah to King Nebukadnezzar for Babilon, na so too I go give King Hofra for Egypt to en enemies.’ ”
JER 45:1 For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, Baruk wey bi Neraya pikin, rite evritin wey I tell am. So I sey,
JER 45:2 “Dis na wetin Israel God dey tell Baruk:
JER 45:3 Yu sey, ‘I don taya and I nor get hope again! God don add join all my wahala and naw, my body dey pain mi and I nor get rest!’ ”
JER 45:4 But God tell mi Jeremaya, “Make yu go tell Baruk sey, ‘I go soon skata wetin I build kon rut wetin I plant. I go do like dis for evriwhere for di world.
JER 45:5 Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”
JER 46:1 God tok to mi about di nashons.
JER 46:2 Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.
JER 46:3 Egypt offisa dey shaut, “Make una ready una weapon kon mash go fight!
JER 46:4 Make una ready and klimb una horse! Make una take pozishon kon wear una helmet! Den sharp una spear kon wear una war klot!”
JER 46:5 But God ask, “Na wetin I dey si so? Dem dey turn back, bikos of fear. Babilon sojas win dia sojas and dem kon run. Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.
JER 46:6 Even di sojas wey sabi run well-well, nor fit eskape. Wen dem run rish di nort side for Eufrates River, dem stagga kon fall.
JER 46:7 Who bi dis wey dey flow kom like River Nile; like river wey en wota dey rush enter land?
JER 46:8 Na Egypt dey flow like River Nile; like river wey dey rush enter land. Egypt sey, ‘I go kover di world; I go distroy many towns and di pipol wey dey stay inside.
JER 46:9 Make una kommand di shariot make dem go! Make una send sojas from Ethiopia, Libya and Lydia. Men wey fit fight with shield and bow.’ ”
JER 46:10 Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.
JER 46:11 Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine, but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.
JER 46:12 Oda nashons don hear of una shame and evribody don hear una kry. One soja fall press anoda one and unasef don fall rish groun.
JER 46:13 Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,
JER 46:14 “Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’
JER 46:15 Wetin make una mighty god wey dem dey koll Apis, fall? Na God strike am.
JER 46:16 Una sojas don fall! Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi hurry go house go meet awa pipol, before awa enemies go kill us finish!’
JER 46:17 For der, dem go sey, ‘Make una give Egypt king new name, bikos e too make nois and na dis make am miss all en shance.’
JER 46:18 Mi, God wey dey mighty, I bi king. Na mi bi di God wey dey alive. As Mount Tabor high pass di mountins and Mount Karmel high pass di sea, di enemies wey dey kom attack una, na so dia pawa bi.
JER 46:19 Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves! Dem go turn Memfis to desert and e go bi dirty land where nobody dey stay.
JER 46:20 Egypt bi like fine melu, but sojas from nort go kom attack am like wiked fly wey dey bite pesin.
JER 46:21 Even di sojas wey dem hire lazy like small goat. Instead make dem stand fight, na run dem dey run. Di day for dem to face wahala and ponishment, don kom.
JER 46:22 Wen Egypt pipol si dia enemies dey kom, dem run kon dey hiss like snake. Dia enemies attack dem with axe like pesin wey dey kut tree
JER 46:23 or klear tick forest. Dia men too many to kount and dia sojas many pass ant.
JER 46:24 Dem disgrace Egypt pipol and na doz from nort win dem.
JER 46:25 Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am
JER 46:26 give King Nebukadnezzar and en sojas wey won kill dem. But afta, pipol go stay for Egypt again, as dem do before.
JER 46:27 “So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.
JER 46:28 I go kom meet and save una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una. I go must ponish una, but I go do am to korrect una.
JER 47:1 Before Egypt king attack Gaza, God tok to mi about Filistia sey,
JER 47:2 “Look! Wota dey boil for nort and e go rush kom like river wey dey flow. Dem go kover di land plus evribody and evritin wey dey der. Pipol go dey shaut for help and evribody for di eart go kry well-well.
JER 47:3 Wen dem hear dia enemies shariot sound, dia pawa go fail dem and papa and mama go run leave dia shidren.
JER 47:4 Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. Mi wey bi God go distroy Filistia pipol and all di pipol wey kom from Krete wotaside.
JER 47:5 Bitter wahala don kom meet Gaza pipol and Ashkelon pipol na wen una go stop to kry and pity for unasef?
JER 47:6 Na wen una go kry rish kon sey, ‘Oga God, na wen Yu go stop to kill us with yor swod? Wi beg, make Yu put yor swod down kon rest small!’
JER 47:7 But how di swod won take rest wen I don gi-am work to do? I don kommand am make e attack Ashkelon pipol and doz wey dey di wotaside.”
JER 48:1 Dis na wetin God tok about Moab pipol: “Betta wahala dey kom meet Nebo pipol, bikos dem don distroy and seize Kiriataim town. Dem don skata en strong wall kon make di pipol dey shame.
JER 48:2 Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.
JER 48:3 Horonaim pipol dey kry sey, ‘War don Kom! Dem don distroy us finish o-o!’
JER 48:4 Dem don distroy Moab! Make una hear as en shidren dey kry.
JER 48:5 Make una hear dia kry for di road wey dem dey pass go Luhit. Dem dey kry with pain as dem dey go Horonaim.
JER 48:6 Dem sey, ‘Make una kwik-kwik run for una life! Make una run like donkey for desert!’
JER 48:7 Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get, but naw, yu go die and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god, en prince and priests, go anoda land.
JER 48:8 Doz wey dey distroy go distroy evry town. E nor get any town wey go eskape. Dem go distroy di town dem wey dey di valley with doz ones wey dey di hill too.
JER 48:9 So make una build grave for Moab, bikos dem go soon distroy am. Dem go skata di town and nobody go stay der again.”
JER 48:10 (Pesin wey nor do God work with all en heart, na curse go follow am and na di same curse go follow who nor bring en swod kom out to take kill!)
JER 48:11 God sey, “Moab pipol dey always stay for peace and dem neva ever karry dem go do slave work. Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun; wine wey dem nor dey pour from cup to cup. Yes! Di wine still sweet and en taste still good as e bi before.
JER 48:12 But di time dey kom wen I go send pipol go pour Moab pipol, just as dem dey pour wine. Di wine pot for Moab go empty and dem go break di pot to pieces.
JER 48:13 Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel, na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.
JER 48:14 Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa or sey una strong well-well for war?
JER 48:15 Dem don distroy Moab town and all en pipol; all di fine yong men for der, dem don kill dem finish.
JER 48:16 Di time wen dem go distroy Moab land don near and di wahala go soon start.
JER 48:17 Una wey dey stay near dat nashon, make una mourn for am. Yes! All of una wey know en glory. Make una sey, ‘Si as en strong pawa don break; en glory and en pawa nor dey again.’
JER 48:18 Yu wey dey stay for Dibon, kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san; bikos di pesin wey distroy Moab and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.
JER 48:19 Yu wey dey stay Aroer, make yu stand for road kon look well; den ask di pipol wey dey run, wetin dey happen.
JER 48:20 Dem go ansa, ‘Moab don fall! Make una kry for am, bikos dem don disgrace am. Make una shaut near Arnon River sey, “Moab don skata!” ’
JER 48:21 “Judgement don kom di towns wey dey up and dem bi: Holon, Jahza, Mefaat,
JER 48:22 Dibon, Nebo, Bet-Diblataim,
JER 48:23 Kiriataim, Bet-Gamul, Baal-Meon,
JER 48:24 Keriot and Bozrah: judgement don kom meet di towns wey dey Moab: both di ones wey dey far and di ones wey dey near.
JER 48:25 Dem don break and distroy Moab pipol pawa.
JER 48:26 God sey, “Make Moab stagga kon fall like pesin wey don drink, bikos dem go against mi. Moab go roll on-top en vomit and pipol go laf am.
JER 48:27 Moab pipol, hope una remember how una take laf Israel pipol? Una trit dem like sey dem bi tif.
JER 48:28 Una wey dey Moab, make una komot from town go stay for under rocks! Make una bi like dove wey dey build en house on-top rock.
JER 48:29 Moab pipol too dey proud! I don hear as dem proud and sturbon rish and how dem dey tink of demsef alone.
JER 48:30 Mi wey bi God, I know as dem dey karry body. Dem just dey boast for nor-tin and all di tins wey dem dey do, nor go last.
JER 48:31 So, I go kry for doz wey dey Moab and Kir-Hareset.
JER 48:32 I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol. Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea den kon go Jazer town. But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin, don skata.
JER 48:33 Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.
JER 48:34 Heshbon and Elealeh pipol kry well-well and dem hear dia kry for Jahaz, Zoar, Horonaim and Shelishiyah town. But Nimrim river, don dry.
JER 48:35 I go stop Moab pipol make dem nor dey burn ofrin for where dem for dey woship and offa sakrifice give dia gods.
JER 48:36 So I dey kry from my heart for Moab and Kir-Heres pipol like pesin wey dey blow trumpet and sing burial song, bikos evritin wey dem get, don vanish.
JER 48:37 All of dem don shave dia hair and barber dia bear-bear. Dem wear sak kon kut dia hand, so dat di marks go show sey dem dey mourn.
JER 48:38 On-top Moab house and for di meetin place, na only pipol wey dey mourn and kry dey der, bikos I don break Moab like pot wey pipol nor won use again.
JER 48:39 Moab don skata! Make una kry well-well, bikos dem don disgrace Moab. Di town don skata and all di nashon wey dey round am, dey laf am.
JER 48:40 God don promise sey, “One nashon go rush kom Moab land like eagle wey spread en feada
JER 48:41 and dem go seize di town and all en strong building. For dat day, Moab sojas go dey fear like woman wey won born.
JER 48:42 Moab go skata and nobody go know am again, bikos God don curse am.
JER 48:43 Wahala, pit wey dem dig and trap wey dem set, dey wait for Moab pipol.”
JER 48:44 God still sey, “Anybody wey try eskape di wahala go fall enter di pit and anybody wey fit kom out from di pit go enter trap, bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.
JER 48:45 Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.
JER 48:46 Curse dey Moab land! Di pipol wey dey woship Kemosh don skata and di enemies don karry dia shidren go as prisonas.
JER 48:47 But di day dey kom wen God go make Moab prosper again. Dis na wetin God sey go happen to Moab land.”
JER 49:1 Dis na wetin God tok about Ammon pipol: “Una tink sey nobody remain for Israel again? Abi una feel sey dem nor dey again so nobody go kollect dia land back? Na dis make una dey woship Molek bikos una don take-ova Gad land kon dey stay der?
JER 49:2 But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois, den dem go distroy and burn dia village rish groun. Den Israel pipol go take dia land back from doz wey take am from dem.
JER 49:3 Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.
JER 49:4 Ammon pipol! Why una nor dey faithful and dey boast? Wetin make una dey bilive sey una money go save una kon dey ask, ‘Na who go try to attack us?’
JER 49:5 I go make fear katch una from evriwhere and all of una go run. Evribody go run for dia life and nobody go gada una wey remain again.
JER 49:6 But afta, I go make Ammon prosper again.
JER 49:7 Dis na wetin God wey mighty tok about Edom: “Teman pipol nor sabi judge well again? Who dey advise Edom nor fit tell dem wetin dem go do? Abi all dia sense and wisdom don vanish?
JER 49:8 Dedan pipol, make una run go hide! I go distroy Esau shidren-shidren, bikos di time don rish for mi to ponish dem.
JER 49:9 Wen pipol dey pick grape, dem dey leave small for di vine and wen tif kom tif for nite, dem dey take only wetin dem wont.
JER 49:10 But I don naked Esau shidren-shidren finish kon open where dem hide put, so dat dem nor go fit hide again. Dem don distroy Edom pipol and nobody among dem remain.
JER 49:11 Shidren wey nor get papa and mama, make yu leave dem for mi and I go kare for dem. Wimen wey nor get husband, make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”
JER 49:12 God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!
JER 49:13 I don swear sey Bozrah town go turn desert wey go dey make pipol fear; pipol go laf and use dem as curse. I go skata all di village wey dey around dem forever.
JER 49:14 So I kon go meet and tell Edom pipol sey, “I don receive message from God. E don send messenja go tell all di nashons sey make dem gada dia sojas and make dem ready kon attack una.
JER 49:15 God go make una weak among oda nashon and nobody go respet una again.
JER 49:16 Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.”
JER 49:17 God sey, “Di wahala wey dey kom meet Edom pipol go bad well-well and wen pipol si am, dem go shok and fear go katch dem.
JER 49:18 Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah, go happen to Edom pipol; God go distroy dem and di village wey dey round dem. Nobody go ever stay der again.
JER 49:19 “Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?
JER 49:20 So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town. Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land finish bikos of di tins dem do.
JER 49:21 Wen Edom fall, di nois go make di whole eart shake and even as Akaba far rish, pipol go hear dia kry.
JER 49:22 Enemies go attack Bozrah land like eagle wey spread en feada. For dat day, Edom sojas go dey fear and shake like woman wey won born.”
JER 49:23 Dis na wetin God tok about Damaskus: “Di pipol for Hamat and Arpad town dey worry and dem nor get rest, bikos dem hear bad news. Dia mind dey trobol dem like river and dem nor fit rest.
JER 49:24 Damaskus pipol don weak and dem kon run, bikos dem dey fear. Dem dey feel pain like woman wey won born.
JER 49:25 Di town wey full with happiness before, wey pipol know well-well, don empty finish.
JER 49:26 For dat day, dem go kill all di yong men for di town kon distroy dia sojas.
JER 49:27 I go set fire for Damaskus wall and e go burn King Ben-Hadad palis rish groun.
JER 49:28 Dis na wetin God tok about Kedar and Hazor kingdom, wey King Nebukadnezzar for Babilon, win: “Make una katch Kedar pipol kon distroy doz wey dey east!
JER 49:29 Make una seize dia tent, animals, curtain and evritin wey dey der. Make una take dia kamels, den tell di pipol sey, ‘Na fear go kill una!’
JER 49:30 Hazor pipol, mi wey bi God dey warn una sey ‘Make una run go hide, bikos King Nebukadnezzar don plan against una and dis na wetin e tok,
JER 49:31 “Kom, make wi go attack doz pipol wey dey save and sikure! Dia town nor get gate or wetin dem take dey lock am, so dem nor dey protet am.
JER 49:32 So, I go take dia kamel and all dia animals! I go skata pipol wey kut dia hair kon bring wahala kom meet dem from evry side.
JER 49:33 Hazor go turn desert forever and na only jackals go dey stay der. Nobody go ever stay der again.” ’
JER 49:34 Afta Zedekaya just bi king for Judah, God tok to mi about Elam town.
JER 49:35 E sey, “I go kill all di sojas wey dey guide and protet Elam pipol.
JER 49:36 I go make breeze blow against Elam from difren direcshon kon skata en pipol go evriwhere, until en pipol don run go hide for all di kountry wey dey dis world.
JER 49:37 I go make Elam pipol fear dia enemies. Bikos I dey vex, I go distroy Elam pipol kon send sojas go porshu dem until I don kill all of dem finish.
JER 49:38 I go distroy dia kings and leaders kon build my throne for der.
JER 49:39 But afta, I go make Elam pipol prosper again.
JER 50:1 God tok thru Profet Jeremaya about Babilon and en pipol. E tell am sey,
JER 50:2 “Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
JER 50:3 Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon. Babilon go turn desert where nobody dey stay, bikos en pipol and animals go run komot der.’ ”
JER 50:4 God sey, “Wen dat time rish, Israel and Judah pipol go kry kom find mi wey bi dia God.
JER 50:5 Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion. Dem go make kovenant wey nor dey end with mi and dem nor go break am.
JER 50:6 My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.
JER 50:7 Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’
JER 50:8 So Judah pipol, make una kwik-kwik komot from Babilon! Make una bi di pipol wey go first komot from der. Make una bi like man goat wey dey lead di oda goats.
JER 50:9 Bikos I dey bring many strong nashons from di nort and dem go attack and distroy Babilon. Wen dia strong sojas shot dia arrow, e go-go meet and kill who dem shot am to! Dem nor dey miss at-all.
JER 50:10 Dem go tif and karry evritin wey dey Babilon.
JER 50:11 God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.
JER 50:12 But dem go disgrace una and shame go katch dis great town. Babilon go bi last among nashons wey dem dey fear; e go dry kon turn empty desert.
JER 50:13 Afta I don vex ponish Babilon, nobody go stay der again. Dem go distroy am finish. Doz wey dey waka pass go si am kon sopraiz well-well, bikos of di wahala wey don happen to am.
JER 50:14 All di sojas, make una ready to attack Babilon. Make una shot una arrows against di town, bikos dem don sin against God.
JER 50:15 Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.
JER 50:16 Make una kill all di farmer wey dey plant for di town. Make all di strenjas go back to dia own pipol. Make dem rush go back to dia land, so dat doz wey dey attack, nor go kill dem join Babilon pipol.”
JER 50:17 God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.
JER 50:18 Bikos of dis, just as I ponish Assyria king, na so mi wey bi Israel God go ponish King Nebukadnezzar and en pipol.
JER 50:19 I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.
JER 50:20 Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life.
JER 50:21 God sey, “Make una go attack, kill and distroy Merataim and Pekod pipol! Make una do evritin wey I kommand una.
JER 50:22 Dem go hear war nois for Babilon. Pipol go hear as dem dey distroy Babilon towns.
JER 50:23 Before, Babilon pipol skata di whole world. But naw, dat hammer wey dem use, don skata. Pipol shok as dem si wetin happen to di kountry.
JER 50:24 I set trap for Babilon and e katch dem, before dem know. Una fight against mi and na dis make dem katch and distroy una.
JER 50:25 I don open di place where I keep my swods and war tins put. I don karry di swod wey I go take distroy, bikos mi, di Oga God wey dey rule evritin, get work to do for Babilon.
JER 50:26 Make una from far kom attack Babilon! Skata where dem keep dia food put! Gada am like dirty kon distroy am finish! Make una kill evribody wey dey der!
JER 50:27 Make una kill all dia sojas anyhow! Babilon pipol own don finish, bikos di time don rish wen I must ponish dem.
JER 50:28 (Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)
JER 50:29 Tell di sojas make dem attack Babilon. Make evribody wey sabi shot bow, surround di town so dat nobody go eskape. Una must pay dem back kon trit dem, just as dem trit odas, bikos dem dey karry body for mi wey bi di Holy One for Israel.
JER 50:30 For dat day, dem go kill all di yong men for di town and all dia sojas go die too.
JER 50:31 God sey, “Babilon pipol, bikos una too karry body, mi wey bi God, dey against una! Time don rish wen I go ponish una.
JER 50:32 Nashon wey dey karry body up, go fall skata and nobody go help am. I go set fire for una town kon distroy evritin.”
JER 50:33 God wey dey mighty sey, “Dem dey opress Israel and Judah pipol. Doz wey katch dem don turn dem to prisonas. Dem nor gri let dem go.
JER 50:34 But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”
JER 50:35 God sey, “Babilon go skata! En pipol, rulers and wise men, go die finish.
JER 50:36 Dem go distroy en profets wey dey lie and pipol go si dem as fools! En sojas go dey die and fear go turn dem to mumu.
JER 50:37 Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
JER 50:38 Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.
JER 50:39 E nor go tey before wild animals go kom take Babilon land and di town go turn where birds dey stay. Pipol nor go ever stay der again and e go dey empty forever.
JER 50:40 Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again.
JER 50:41 Si, strong sojas dey kom from nort. One strong nashon and many kings dey kom attack dem from far.
JER 50:42 Dem karry dia bow and swod; dem wiked and nor dey sorry for pesin. Di nois wey dia horse dey make, bi like river own. Dem dey ready to fight against Babilon pipol.
JER 50:43 Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.
JER 50:44 Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too, mi wey bi God go kom attack and porshu Babilon pipol komot from dia town. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos nobody bi like mi and who go fit shalenge mi? Wish ruler fit follow mi make mout?
JER 50:45 So make una listin to di plan wey I get against Babilon town and en pipol. Dem go drag dia shidren go like sheep kon skata dia house.
JER 50:46 Wen Babilon fall, di eart go shake and oda nashon go hear as Babilon pipol dey kry with pain.”
JER 51:1 God sey, “I go distroy Babilon and en pipol with strong breeze.
JER 51:2 I go send strenjas kom distroy Babilon like breeze wey blow dirty trowey. Wen dat day rish, dem go attack dem from difren side, until di land go empty.
JER 51:3 Dem nor go give Babilon sojas time to even shot arrow or wear dia war klot. Dem nor go sorry for Babilon yong men and dem go distroy all dia sojas.
JER 51:4 Dem go wound kon fall die for all di street wey dey dia towns.
JER 51:5 Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol, even doh dem sin against mi wey bi di holy God for Israel.
JER 51:6 So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.
JER 51:7 Babilon pipol bi like gold cup for my hand a nd di wine for inside dey shark di whole world. Di nashons drink from am and dem kon start to bihave anyhow.
JER 51:8 But na wons Babilon fall kon skata. Make una mourn for am! Make una find medicine for am, may bi dat one fit cure am.
JER 51:9 Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”
JER 51:10 God sey, “My pipol, make una shaut sey: ‘God don show sey wi dey do di rite tin. So make wi go tell doz wey dey Jerusalem wetin God do for us.’
JER 51:11 So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!
JER 51:12 Make una give sign make dem go attack Babilon. Give di guide pawa kon put dem for dia pozishon, den una go hide some men for bush too!’ God don do wetin E sey E go do to Babilon pipol.
JER 51:13 Una wey dey stay along Babilon river, una end don near well-well. Una wey rish well-well with propaty wey una tif, dis na di time to kill una.
JER 51:14 God wey dey mighty, don swear with ensef sey, E go bring many pipol kon attack Babilon like ant and dem go shaut dey happy.”
JER 51:15 God make di eart with en pawa; na en wisdom E take kreate di world kon spread di heavens with en sense.
JER 51:16 Wen E kommand, di wota on-top sky dey make nois like wen lion dey shaut. E make di kloud kom out from di rite place. E make lite kom out for rainin sizin kon send breeze kom from where E keep dem put.
JER 51:17 Wen pipol si dis tins, dem dey bi like fool wey nor get sense. Doz wey dey make juju, na di juju dey disgrace dem; di gods wey dem make, nor bi betta god and e nor even get life.
JER 51:18 Dem dey yuzles and pipol dey use dem make yeye. Den wen di time rish, God go distroy all of dem.
JER 51:19 Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. Na God wey get pawa, bi en name.
JER 51:20 God sey, “Babilon pipol, una bi my hammer and swod wey I dey use take fight. I use una take skata nashons and kingdoms.
JER 51:21 I still use una take skata horse, shariot and di pipol wey dey ride dem.
JER 51:22 Na so too, I use una take kill men and wimen; kut both old and yong pipol and kill boys and girls too.
JER 51:23 I still use una take kill shepads and dia animals; kill pipol wey dey tif and dia horse; den skata rulers and ofisas.
JER 51:24 But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.
JER 51:25 Babilon! Yu bi like mountin wey distroy di whole world, but mi wey bi God, na una enemy. I go katch, skata and burn una to ashes.
JER 51:26 Di stone wey skata for una town, una nor go fit use am take build house again. Una go bi like desert forever.
JER 51:27 Make una give dem sign to attack! Make una blow trumpet, so dat di nashon go hear! Ready di nashons, so dat dem go fight against Babilon pipol! Tell Ararat, Minni and Ashkenaz kingdom make dem attack Babilon. Make una choose one offisa wey go lead dem go attack and bring all di horse kom back like many ant.
JER 51:28 Prepare di nashons make dem go fight against Babilon pipol. Send messenjas make dem go koll Media kings, dia leaders, ofisas and di sojas for all di kountries wey dem dey kontrol.
JER 51:29 Di eart dey fear and shake, bikos God dey do wetin E plan wen E sey E go turn Babilon to desert where pipol nor dey stay.
JER 51:30 Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.
JER 51:31 Difren messenjas go run go tell Babilon king sey dem don break en town enter from difren korna.
JER 51:32 Enemies don seize di river wey dem dey pass kon burn all dia strong and betta house and Babilon sojas dey fear well-well naw.
JER 51:33 E nor go tey before enemies go kut dem for groun like korn wey dem dey pick for farm.
JER 51:34 King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.
JER 51:35 Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us, na so too God go sofa dem and make God pay dem back, bikos dem kill awa pipol.’ ”
JER 51:36 Dis na wetin God tell Jerusalem pipol: “I go bi una lawyer kon judge una kase, den I go fight for una. I go dry Babilon rivers.
JER 51:37 Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.
JER 51:38 En pipol go shaut like lion wey dey find food; like lion shidren wey dey hongry.
JER 51:39 As dem dey hongry, I go prepare food, so dat dem go chop and drink kon happy. Den dem go sleep kon die go like dat.
JER 51:40 I go karry dem go kill like lamb, goats and rams.”
JER 51:41 God tok about Babilon sey: “Dem don seize di town wey di whole world dey praiz! Naw, e don turn where nashons dey fear to stay.
JER 51:42 Di sea rush enter Babilon and naw e don kover di town.
JER 51:43 Di town don turn where pipol dey fear to stay and e bi like desert wey nor get wota; where pipol nor dey stay or travel pass.
JER 51:44 I go ponish Bel wey bi Babilon god and make am drop all di tins wey e tif and di nashons nor go woship am again. Naw, Babilon wall don fall.
JER 51:45 So Israel pipol, make una run komot from der! Make una run for una dear life and from my vexnashon.
JER 51:46 Make una nor fear or luz hope, bikos of wetin una hear. Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land and dem go sey one king dey fight anoda one.
JER 51:47 So di time dey kom wen I go deal with Babilon juju. Di whole kountry go shame and dem go kill all en pipol.
JER 51:48 Den evritin wey dey heaven and eart go dey happy wen Babilon pipol go fall, wen doz sojas from nort don distroy dem.
JER 51:49 Na Babilon kill many pipol for dis world. Yes! Babilon go fall, bikos na-im make many Israel pipol die.
JER 51:50 God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”
JER 51:51 Di pipol sey, “Wi dey shame, dem don insult and disgrace us, bikos strenjas don dirty God temple.”
JER 51:52 God sey, “Yes! Di time dey kom wen I go distroy all Babilon juju and for evriwhere for di land, dem go dey hear doz wey wound dey kry bikos of dia pain.
JER 51:53 Even if Babilon klimb go sky kon build strong house for der, I go still send pipol go distroy am.
JER 51:54 God sey, “Make una listin as dem dey kry for Babilon town. Dem dey mourn, bikos of how dem distroy di land.
JER 51:55 I go distroy Babilon and nobody go hear en vois again. Sojas go rush kom attack dem like wota for sea and dem go sey,
JER 51:56 ‘Wi don distroy Babilon. Wi don seize en sojas kon break dia bow.’ I bi di God wey dey ponish bad pipol and I go pay Babilon back.
JER 51:57 I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again.
JER 51:58 Dem go distroy Babilon strong wall kon burn dia big-big gate. Evritin wey Babilon build, go skata go like dat.”
JER 51:59 Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.
JER 51:60 Evritin about di distroshon wey go happen to Babilon pipol and some oda tins about Babilon, I rite dem down for book.
JER 51:61 Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu.
JER 51:62 Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’
JER 51:63 Seraya, wen yu don read dis book finish for di pipol, tie am for stone and trow am inside Eufrates River kon
JER 51:64 sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ” Na here Jeremaya message for finish.
JER 52:1 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule Judah and e rule Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey dey stay Libnah town, born am.
JER 52:2 King Zedekaya sin against God, just as King Jehoiakim do.
JER 52:3 Bikos God dey vex for Jerusalem and Judah pipol, E kon porshu dem komot for en present go Babilon town. So Zedekaya kon plan against Babilon king
JER 52:4 and for di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar lead en sojas go fight against Jerusalem. Dem surround di town kon build dia tent near di wall.
JER 52:5 Dem stay round Jerusalem until di elevent year wey King Zedekaya dey rule.
JER 52:6 For di ninet day for di fourt mont for dat same year wey Zedekaya don dey rule, di honga for di town kon sirious bikos di food wey remain, don finish.
JER 52:7 Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.
JER 52:8 But Babilon sojas porshu King Zedekaya kon katch am for Jeriko road, but en men run leave am.
JER 52:9 Dem take am go meet Babilon king for Riblah for Hamat land. Den Babilon king judge am for der.
JER 52:10 E make Zedekaya dey look as dem dey kill en shidren and all en oda ofisas for Judah.
JER 52:11 Den dem blind Zedekaya eye, tie am with shain kon karry am go Babilon. Zedekaya stay prison till e die.
JER 52:12 For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.
JER 52:13 E burn God temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. E distroy all di betta-betta house for di town
JER 52:14 and en sojas kon skata di town wall.
JER 52:15 Den Nebuzaradan karry di pipol wey remain for di town go Babilon as slave. Di pipol wey remain for di town, na di kraftmen and doz wey ready to serve Babilon king.
JER 52:16 But e leave some poor pipol for Judah make dem kare for di vineyards and farms.
JER 52:17 Babilon pipol break di two bronze pilas wey dey God temple front; di bronze wota pot and di big bronze basin, wey dem still dey koll, “Di Sea.” So dem karry all di bronze go Babilon.
JER 52:18 Dem still karry ash buckets, shovels, lamp, basins, plates and oda bronze tins wey dem dey use take make sakrifice for di temple.
JER 52:19 Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.
JER 52:20 Di two pilas, di Sea with di twelf bronze melu image wey dey under am and di wota pot and wetin dem karry, many well-well. Dem make and put dis tins for God temple wen King Solomon dey rule.
JER 52:21 “Each of di pila high rish twenty-seven fit kon wide rish eight fit. Dem tick rish three inches and dem get holes.
JER 52:22 Di bronze on-top each pila high rish seven and half fit and dem dekorate am with pomegranate kon put ornament.
JER 52:23 Na ninty-six pomegranate fruit dey for each side; di total for evritin na, one hundred pomegranate with di ornament wey dey around di top.”
JER 52:24 Nebuzaradan wey bi di ofisas oga, take Seraya wey bi di High Priest, Zefanaya wey bi di sekond priest with three shief wey dey keep di gate kon karry dem go as prisonas.
JER 52:25 From among di pipol wey dey for di town, e take one offisa wey bin dey kare for Jew sojas; seven of di king pesinal advise, di soja kommander, shief seketry and sixty oda pipol.
JER 52:26 Nebuzaradan, take all of dem go meet Babilon king for Riblah.
JER 52:27 So Babilon king kill all of dem for Riblah wey dey Hamat land. So dem karry Judah pipol komot from dia own land go Babilon.
JER 52:28 Di pipol wey Nebukadnezzar karry as prisonas for di sevent year wey e bi king for Babilon, na 3,000 and twenty three.
JER 52:29 Den for en eighteent year for di throne, e karry eight hundred and thirty-two pipol from Jerusalem.
JER 52:30 And wen e don rule for twenty-three years, e send Nebuzaradan go karry seven hundred and forty-five pipol kom. So all di pipol wey dem karry as prisonas na, 4,600.
JER 52:31 For di year wey dem make Evil-Merodak king for Babilon, e sorry for King Jehoiashin for Judah kon release am from prison. Dis tin happen for di twenty-five day for di twelft mont for di thirty-seven year afta dem take Jehoiashin go Babilon as prisona.
JER 52:32 King Evil-Merodak follow Jehoiashin tok well kon gi-am pozishon wey pass di oda kings wey dem karry kom Babilon as prisonas.
JER 52:33 So e allow Jehoiashin shange en prison klot, den Jehoiashin kon always dey chop from di king tabol until di day wen e die.
JER 52:34 Babilon king dey gi-am evritin wey e wont until di day wen e die.
LAM 1:1 Jerusalem, where many pipol dey stay before, don empty naw. Di town wey great pass oda nashons before, don bi like woman wey en husband die leave. Na Jerusalem bi kween for di world before, but naw, na slave e bi.
LAM 1:2 Jerusalem pipol dey kry well-well for nite. Doz wey love am nor dey again to konfort am and all en friends don lie for en head; dem don turn en enemy.
LAM 1:3 Dem karry Judah pipol go Babilon as slave kon dey sofa dem. Na anoda land dem dey stay and dem nor get peace at-all. Even with di pain wey dem dey pass thru, evribody wey porshu dem, katch and ponish dem.
LAM 1:4 Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!
LAM 1:5 Jerusalem enemies don turn dia oga naw and dem dey prosper, bikos God ponish Jerusalem pipol for di sins wey dem kommit. Dem don katch and take dia shidren go far land.
LAM 1:6 All di glory wey Jerusalem get, don vanish. En prince bi like deer wey dey find grass to chop, bikos e dey hongry. Dem too dey weak to run from dia enemies wey dey porshu dem.
LAM 1:7 Even inside en pain, Jerusalem remember wen e nor get money or house to stay. E still remember all di propaty wey e bin get. But naw, en enemies don attack am and nobody gri kom help am. Di way e take fall, dey make en enemies laf.
LAM 1:8 Bikos Jerusalem sin well-well, God kon rijet dem like dirty rag. All di pipol wey dey honor am before, don hate am naw, bikos dem don si en nakednes and shame. Di only tin wey e fit do naw, na to dey kry with pain and hide en face with shame.
LAM 1:9 E nor keep ensef klean or tink of wetin go happen to am. Naw, e dey inside gutta and nobody won bring am out. So e kry kon sey, “Oga God, make Yu si wetin dey happen to mi; my enemies don win mi.”
LAM 1:10 Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.
LAM 1:11 En pipol dey feel di pain and dem dey find wetin dem go chop. E sell en betta-betta tins make e for si money take buy food chop, so dat e nor go die. So e kry, “My God, make Yu look kon si as I dey sofa.”
LAM 1:12 Una wey dey waka pass, my sofa nor mean anytin to una? Make una look round, una si anybody wey dey sofa like mi? But na God vexnashon dey kause dis pain and sofa for mi.
LAM 1:13 E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.
LAM 1:14 E know all my sins; so E put dem togeda kon hang and tie dem round my neck. I weak well-well, bikos my sins too heavy. God don make my enemies strong pass mi and I nor fit do dem anytin.
LAM 1:15 God don turn all my strong sojas to fool. As E kommand, many sojas kom distroy my sojas. God mash and press my pipol, just as dem dey press grape.
LAM 1:16 Bikos of dis tins; I kry well-well, but nobody dey to konfort or give mi hope. My shidren nor get future, bikos awa enemies don win us.
LAM 1:17 Jerusalem dey beg for help, but nobody gri help am. God don tok against Jakob sey, “Doz nashons wey dey around yu, go bi yor enemies! Dem go ponish and trowey Jerusalem like dirty rag!”
LAM 1:18 Jerusalem sey, “God dey rite, bikos I go against en kommand. So pipol for evriwhere, make una listin kon si as I dey sofa! Dem don karry my shidren go Babilon as slave.
LAM 1:19 I koll all di pipol wey love mi make dem help mi, but instead, dem kom deceive mi. Na honga kill my priests and leaders for di town wen dem dey find food wey dem go chop.
LAM 1:20 So my God, make Yu si as I dey sofa! My heart dey kry, bikos of my sins. Dem dey kill pipol for di street and even deat dey inside house too dey wait mi.
LAM 1:21 Even doh dem hear sey I dey sofa, nobody gri kom konfort mi. My enemies know sey I dey trobol and dem dey happy to si as God ponish mi. Make di Judgement Day wey Yu promise kom, so dat dem go sofa, just as I don sofa so.
LAM 1:22 My God, make yu si all di wiked tins wey dem dey do. Make Yu ponish dem, just as Yu ponish mi for all my sins. My pains many and e dey make mi sick well-well.”
LAM 2:1 God disgrace Zion bikos E dey vex. E don trowey Israel pride from heaven kom down and E nor protet di temple again bikos E really dey vex with dem.
LAM 2:2 God nor sorry for Jakob shidren-shidren, instead E distroy dia house. Wen E dey vex, E break Jerusalem strong fine wall kon disgrace di kingdom with doz wey dey rule am.
LAM 2:3 E vex distroy Israel pipol pawa; E nor gri help Israel wen dia enemies kom attack dem. Just as fire dey distroy tins, na so too E distroy Israel land.
LAM 2:4 E set arrow kon shot us like sey wi bi en enemies. Yes, en rite hand dey ready to shot. E kill us with awa strong men kon pour en vexnashon like fire for Zion head.
LAM 2:5 God distroy Israel like sey E bi awa enemy. E distroy all di palis dem kon skata awa betta towns. E make evribody for Judah kry and mourn.
LAM 2:6 E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.
LAM 2:7 God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.
LAM 2:8 God won distroy Jerusalem fine wall. E dey plan to distroy am and E go do wetin E plan. Den E go skata di towas and di walls rish groun.
LAM 2:9 Di town gates don sink enter groun. E skata all di keys and bars wey dem take dey lock di gates. Dem take en prince dem and kings go Babilon as slave. Law nor dey again and God profets nor dey get any vishon from am again.
LAM 2:10 Jerusalem leaders sidan kwayet for groun. Dem wear sak klot kon pak dust put for dia head and di yong wimen kover dia face for groun with shame.
LAM 2:11 I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.
LAM 2:12 Dem dey kry give dia mama sey, “Wi wont chop and drink!” Dem dey faint for di town like sojas wey wound for war and dem dey die small-small for dia mama hand.
LAM 2:13 Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?
LAM 2:14 Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.
LAM 2:15 Pipol wey dey pass di town dey look una with shame. Dem dey laf and shake dia heads, bikos Jerusalem don skata. Dem sey, “Nor bi di fine town wey di world bin like well-well bi dis?”
LAM 2:16 All yor enemies dey laf and happy sey, “At last, wi don distroy am! Wi don dey wait for dis day since and naw, e don kom.”
LAM 2:17 But na God do wetin E plan. E don do wetin E promise and E warn us about am since. E nor sorry for Jerusalem kon distroy am. E give awa enemies viktory and dem dey happy, bikos God don distroy us.
LAM 2:18 Jerusalem wall wey fine well-well, make yu kry give God! Both day and nite, make di wota from yor eye dey flow like river! Make yu nor rest or stop to kry!
LAM 2:19 Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.
LAM 2:20 Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?
LAM 2:21 Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.
LAM 2:22 Just as dem dey invite pesin for party, na so too Yu invite my enemies and I kon dey fear. For di day wey God dey vex, nobody go fit eskape or survive am. Naw, my enemies don kill all di shidren wey I born and train.
LAM 3:1 I bi one pesin wey know wetin e mean wen God ponish yu.
LAM 3:2 E don porshu mi and naw I dey waka for darkness.
LAM 3:3 Evritime, na only mi E dey always ponish.
LAM 3:4 E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.
LAM 3:5 Na sofa and wahala E pak full my life.
LAM 3:6 Even doh I neva die, E beri mi for darkness like pesin wey don die.
LAM 3:7 E don tie mi with shain like prisona wey nor get hope to eskape.
LAM 3:8 I kry well-well make E help mi, but God nor gri ansa mi.
LAM 3:9 E use big-big stones take block evriwhere wey I dey pass and I nor know di rite road again.
LAM 3:10 To mi, E hide like bear or lion wey dey wait to attack pesin.
LAM 3:11 E drag mi komot for road; tear mi to pieces kon leave mi and nobody dey to help mi.
LAM 3:12 E set en arrow to take shot mi die
LAM 3:13 and naw, E don shot mi and di arrow enter my heart.
LAM 3:14 I don turn pesin wey pipol dey laf and sing yeye song for.
LAM 3:15 Na bitterness and sofa bi di food and drink wey God dey give mi.
LAM 3:16 E don use my face rub groun kon break my tit with stone.
LAM 3:17 I nor know wetin peace mean again and I don forget as happiness dey bi.
LAM 3:18 Den I kry kon sey, “I nor get respet again! I don lost evritin wey I hope to get from God!”
LAM 3:19 Wen ever I remember as I take sofa without house to sleep, e dey pain mi like poizin for my belle.
LAM 3:20 I nor go ever forget di time wen I take sofa; wen I bin dey mourn, bikos of evritin wey I lost.
LAM 3:21 Anytime I remember all dis tins, I know sey I still get hope.
LAM 3:22 God faithful love nor dey end! And en mesi nor dey finish.
LAM 3:23 Wi dey always trust Yu bikos na evriday Yu dey show us yor goodness.
LAM 3:24 I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”
LAM 3:25 God dey good to pipol wey trust and dey find am.
LAM 3:26 So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.
LAM 3:27 And na naw wey wi still dey yong, wi suppose learn how to get patient as wi dey wait for God.
LAM 3:28 Make wi sidan kwayet wen God dey deal with us.
LAM 3:29 Make wi bow face groun, may bi na den God go give us hope again.
LAM 3:30 Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
LAM 3:31 Bikos God nor go forget us forever.
LAM 3:32 Even doh sey E dey make us sofa naw, E still dey sorry for us, bikos en great love for us nor dey end.
LAM 3:33 God nor like to sofa pipol or make dem kry.
LAM 3:34 So to dey opress pipol for dis world,
LAM 3:35 to shit pipol kon kollect wetin bi dia own, God wey dey heaven dey si evritin
LAM 3:36 and E know dey happy wen dem nor give pesin korrect judgement for kourt.
LAM 3:37 So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
LAM 3:38 Nor bi from God mout evritin from kom? Both good and bad?
LAM 3:39 Den, why wi human being go dey komplain if dem ponish us for awa sins?
LAM 3:40 Instead, make wi shek and test di tins wey wi dey do kon turn from sin kom meet God.
LAM 3:41 Make wi lift awa hand and heart to God for heaven kon sey,
LAM 3:42 “Wi don sin and go against Yu and na dis make Yu dey vex for us.
LAM 3:43 Yu don hide yorsef bikos Yu dey vex and Yu porshu us komot for yor front. Yu nor even pity for us wen Yu dey kill us.
LAM 3:44 Yu hide yorsef for di kloud, so dat awa prayers nor go rish where Yu dey.
LAM 3:45 Yu don make us bi like dirty rag for all di oda nashons front.
LAM 3:46 All awa enemies dey tok bad against us.
LAM 3:47 Wi dey fear, bikos wi dey trap; wi don konfuse and distroy awasef.
LAM 3:48 Wota dey rush kom out from my eye, bikos dem don distroy my pipol finish.
LAM 3:49 I still dey kry well-well and I nor go stop at-all
LAM 3:50 until God go look from heaven kon si wetin don happen.
LAM 3:51 My heart heavy well-well wen I si wetin happen to di wimen for dis town.
LAM 3:52 Pipol wey I nor do bad to, set trap for mi like sey I bi bird.
LAM 3:53 Dem trow mi inside one pit kon dey drop stone for my head.
LAM 3:54 Dem dey pour wota put for my head and I tink sey na die I dey.
LAM 3:55 But from inside di deep pit, I kon koll Yu wey bi my Oga God.
LAM 3:56 Yu hear my kry for help wen I sey: ‘God make Yu listin to mi well-well!’
LAM 3:57 Yes! Wen I koll Yu, Yu kom tell mi sey, ‘Nor fear.’
LAM 3:58 Oga God, na Yu bi my lawyer, so make Yu judge my kase, bikos Yu don save my life.
LAM 3:59 Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi. So my God, make Yu judge my kase, so dat pipol go know sey I dey rite.
LAM 3:60 Yu don si all dia plans to revensh mi.
LAM 3:61 Yu don hear all di wiked names wey dem dey koll mi and Yu know all di plans wey dem don make.
LAM 3:62 Evriday, my enemies dey tok as dem dey plan against mi.
LAM 3:63 Si dem! Weda dem sidan or stand, na mi dem dey laf and take dey sing.
LAM 3:64 So Oga God, make Yu pay dem back for all di bad tins wey dem don do.
LAM 3:65 Make Yu give dem sturbon and strong heart, so dat yor curse go dey dia head.
LAM 3:66 So as Yu dey vex, make Yu porshu and distroy dem komot dis world.”
LAM 4:1 Make una si as gold nor dey yuzful again. Di gold wey fine and dey shine well-well before, nor dey shine again and di temple stones don skata for di street.
LAM 4:2 Just as gold dey important and get value, na so too Jerusalem shidren dey important before, but naw, pipol dey trit dem like ordinary pot wey dem make with klay.
LAM 4:3 Even as jackals wiked rish, dem still dey give dia shidren breast make dem suck, but my pipol wiked like ostrich for desert.
LAM 4:4 Dia shidren tongue don gum, bikos dem nor si wota drink; dem dey beg waka, but nobody gri give dem food chop.
LAM 4:5 Pipol wey dey chop betta food before, don turn who dey beg food for street. Pipol wey dey wear fine and betta klot before, don turn who dey wear rag naw.
LAM 4:6 Di ponishment wey I give my pipol worse pass Sodom pipol own, bikos na wons e take happen and nobody dey to help dem.
LAM 4:7 Before-before, dia prince dem shine pass snow and white pass milk. Dia body smooth pass rubi stone and wen yu si dem, dem dey shine pass safaya stone.
LAM 4:8 But naw, dia face don black pass black powder and wen dem dey waka for street, pipol nor even know dem again. Dia body don tin finish and dem dry like dry wood.
LAM 4:9 Pipol wey die for war, betta pass doz wey hongry kill, bikos na food wey dem nor si chop, kill dem.
LAM 4:10 Wen dem distroy my pipol, even wimen wey love dia shidren, dey kook dem chop, bikos of honga.
LAM 4:11 But naw, God don pour en vexnashon finish. E don send fire kon burn Jerusalem town rish groun.
LAM 4:12 Before, pipol and kings for oda nashons nor ever tink sey enemies go fit attack Jerusalem, tok-less of to skata am.
LAM 4:13 But dis tin happen, bikos of di sin wey di profets and di priests kommit and bikos of di innocent pipol for di town, wey dem kill.
LAM 4:14 Dem dey waka anyhow for di street like sey dem nor dey si; dis na bikos dem don stain diasef with blood and naw, pipol nor fit tosh dem again.
LAM 4:15 Naw, pipol dey shaut for dem anyhow sey, “Komot for here! Una wey dey smell! Make una nor tosh us!” So dem kon komot der go anoda town, but any town wey dem waka go, di pipol dey porshu dem.
LAM 4:16 Na God skata dem and E nor dey help dem again. Pipol nor dey respet dia priests or honor di leaders again.
LAM 4:17 Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.
LAM 4:18 Awa enemies dey wosh awa movement and naw, wi nor fit waka for di street again. Awa days for dis world don almost finish, bikos wi go soon die.
LAM 4:19 Doz wey dey porshu us, fast pass eagle wey dey fly for sky. Dem porshu us pass di mountin kon set trap for us for wildaness.
LAM 4:20 Dem katch di pesin wey make us dey alive, di king wey God choose and wi bin get hope sey e go protet us from awa enemies.
LAM 4:21 Edom pipol wey dey stay for Uz land, make una dey laf naw. Make una know sey dis judgement cup go rish where una dey too; una go drink from am until di drink don shark una and una go kon naked.
LAM 4:22 Jerusalem pipol, God nor go ponish una again, instead E go take una komot from Babilon go back to una own land. But una wey kom from Edom, make una nor worry, God go ponish una, bikos of una sins.
LAM 5:1 Awa God, make Yu tink about dis tins wey dey happen to us naw and how awa enemies don disgrace us rish.
LAM 5:2 Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw.
LAM 5:3 Wi don turn shidren wey nor get papa and awa mama don turn who en husband don die.
LAM 5:4 Wi must pay money to drink awa own wota and buy awa own firewood too.
LAM 5:5 Dem really dey porshu us and naw, wi don taya, but wi nor fit rest at-all.
LAM 5:6 Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.
LAM 5:7 Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment.
LAM 5:8 Doz wey bi awa slave before, don turn awa oga naw and nobody dey to save us from dia pawa.
LAM 5:9 Wi dey risk awa life as wi dey find food wey wi go chop, bikos tif many for di towns and di village dem.
LAM 5:10 Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so.
LAM 5:11 Enemies don rape awa wifes for Jerusalem and dem don disgrace awa yong girls for Judah town.
LAM 5:12 Dem hang and kill di kings family kon trit awa eldas anyhow.
LAM 5:13 Dem karry awa yong men go do strong work and awa boys dey stagga, bikos of di heavy wood wey dem dey karry.
LAM 5:14 Awa eldas nor fit sidan for di town gate again and di yong men nor dey dance and sing again.
LAM 5:15 Joy nor dey awa heart again bikos wi wey bin sabi dance, don turn who dey mourn naw.
LAM 5:16 Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.
LAM 5:17 Bikos of dis, wi dey feel pain and wi nor dey si well again; awa eyes don dey weak, bikos wi don kry taya.
LAM 5:18 Mount Zion don empty and nobody dey der again, so naw, na wild animals dey stay der.
LAM 5:19 So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one.
LAM 5:20 But why Yu forget us like dis and wetin make Yu leave us since?
LAM 5:21 My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before.
LAM 5:22 Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?
EZE 1:1 Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.
EZE 1:2 (Dis tin happen for di fift day for di mont wey bi di fift year wey King Jehoiashin bi prisona for Babilon.
EZE 1:3 Na God give dis message to mi Ezekiel Buzi pikin, wey bi priest, near Chebar River for Babilon and I feel en hand for my body.)
EZE 1:4 As I dey look, I si strong breeze dey blow kom from nort and tick kloud with tonda lite dey round am. Fire still dey der too and I si one tin dey shine inside di fire.
EZE 1:5 I still si four creatures wey dey alive inside di fire and dem bi like human being.
EZE 1:6 But each of dem get four face and four feadas.
EZE 1:7 Dia legs strait well-well, but dia toe bi like melu own and e dey shine like bronze wey dem polish.
EZE 1:8 Under dia feadas for di four side, dem get human being hand. All of dem get four face and four feadas
EZE 1:9 and dia feadas dey tosh each oda. Each one dey waka go strait and dem nor dey turn as dem dey waka.
EZE 1:10 Dis na how dia face bi like: Human being face for front, lion face for di rite side, melu face for di left side and eagle face for back.
EZE 1:11 Each of dem get two-two feadas wey dey tosh di oda creature feadas and di oda two feadas dey kover dia body.
EZE 1:12 Each of di creature face di four direcshon, so wen dia spirit won waka go anywhere, dem dey waka without sey dem turn.
EZE 1:13 Among di creatures, e get sometin wey bi like tosh or tick fire and e just dey move. Di fire dey move from front go back, e dey shine well-well and dey bring out tonda lite.
EZE 1:14 Di creatures dey waka go front and back kwik-kwik like tonda lite.
EZE 1:15 As I dey look di creatures, I kon si four wheel for di eart and one dey near each of dem.
EZE 1:16 All di four wheel bi like jasper and each one dey shine like gold and dem build dem like sey one wheel dey inside anoda one.
EZE 1:17 Wen dem dey move, dem fit go any of di four direcshon wey dem face and dem nor dey turn as dem dey move.
EZE 1:18 Eyes full di rims wey dey di four wheel and dem high well-well kon make pipol dey fear.
EZE 1:19 Wen di creatures dey move, di wheels dey move too. Wen di creatures raiz-up komot groun, di wheel go-go up too.
EZE 1:20 Anywhere di spirit won go, dem go-go too and di wheel go follow dem, bikos di creatures spirit dey inside di wheel.
EZE 1:21 Wen di creatures move, di wheels go move too and wen dem stop to waka, di wheels go stop. Wen dem raiz komot groun, di wheels go raiz too, bikos dia spirit dey inside di wheels.
EZE 1:22 Sometin wey flat wey dem make with crystal glass, dey on-top di creatures head.
EZE 1:23 Under di flat crystal glass, dia feadas stresh kom out kon face each oda. Two feadas kover outside, while two dey kover dia body.
EZE 1:24 Wen dem dey waka, I dey hear dia feadas sound. Di sound bi like God vois or wota wey dey rush pass with pawa or like sojas wey gada dey go war. Wen dem stop to waka, dem kon bring dia feadas down.
EZE 1:25 Den, one vois kon tok from di flat crystal wey dey on-top dem.
EZE 1:26 On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
EZE 1:27 I si sometin wey bi like fire wey dey burn from en waist go up. And from en waist kom down, I still si sometin wey bi like fire wey dey burn and di lite wey dey round am, dey shine well-well.
EZE 1:28 Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.
EZE 2:1 God tell mi sey, “Man pikin, stand up make I tok to yu”
EZE 2:2 As God dey tok to mi, en Spirit enter my body kon karry mi stand and I kon listin well to evritin wey E dey tok.
EZE 2:3 E sey, “Man pikin, I dey send yu go meet Israel pipol, bikos dem don turn from mi and still dey do bad tins, just as dia grand-grand papa do.
EZE 2:4 Di pipol wey I dey send yu go meet so, dem sturbon well-well and dem nor dey respet mi. So I dey send yu go tell dem wetin mi, God wey get pawa dey tok.
EZE 2:5 Weda dem listin to yu or not, dem go know sey one profet don kom meet dem.
EZE 2:6 But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.
EZE 2:7 Yu go tell dem evritin wey I sey make yu tok, weda dem listin or not, bikos I know sey dem sturbon well-well.
EZE 2:8 Man pikin, make yu listin to wetin I go tell yu. Make yu nor sturbon like dem. Naw, open yor mout make yu chop wetin I go give yu.”
EZE 2:9 So I si one hand dey kom meet mi and e hold one book wey dem fold.
EZE 2:10 Di hand open di book and dem rite put for di two side. Na kry, mourning and pains dem rite put for di book.
EZE 3:1 God sey, “Man pikin, make yu chop dis book; den go tok to Israel pipol.”
EZE 3:2 So I open my mout and E kon give mi di book make I chop.
EZE 3:3 E sey, “Man pikin, dis book wey I dey give yu so; make yu chop am till yu beleful.” I kon chop am and e sweet like honey.
EZE 3:4 Den God sey, “Man pikin! Go meet Israel pipol make yu tell dem anytin wey I sey make yu tok.
EZE 3:5 I nor dey send yu go where yu nor go hear wetin dem dey tok, but na Israel pipol I dey send yu go meet.
EZE 3:6 Even if I send yu go meet pipol wey dey tok wetin yu nor undastand, dem go still listin to yu.
EZE 3:7 But nobody for Israel go listin to yu, bikos dem nor go even gri listin to mi. All of dem too sturbon and dem nor dey hear word.
EZE 3:8 “Naw, I go make yor heart strong pass dia own and yu nor go fear dem.
EZE 3:9 I go make yu strong like rock and yu go dey hard like diamond: so make yu nor fear dem at-all.”
EZE 3:10 God still sey, “Man pikin, listin well-well kon remember evritin wey I tell yu.
EZE 3:11 Den go tell yor kountry-men for Babilon wetin mi wey bi God dey tell yu; weda dem listin or not.”
EZE 3:12 Den God Spirit karry mi go up and I kon hear one loud vois dey sey, “Praiz and glory na God own for heaven!”
EZE 3:13 I hear di creatures feada dey nak togeda and di wheels kon dey make loud nois like eartkweke.
EZE 3:14 So God pawa enter my body with force and as en spirit dey karry mi go. I kon dey vex, but God hand rest for my head with pawa.
EZE 3:15 Den I kon rish Tel-Abib wey dey near Chebar River, for where di prisonas dey stay and I kon stay der for seven days, but di tins wey I si and hear, fear mi well-well.
EZE 3:16 Afta seven days, God kon tok to mi sey:
EZE 3:17 “Man pikin, I dey make yu di pesin wey go wosh ova Israel pipol. Yu go tell dem di warnin wey I give yu.
EZE 3:18 If I tell yu sey one wiked man go die and yu nor warn am make e shange from di bad tins wey e dey do, if e die, e go still die as sina and I go whole yu, bikos na yu make am die.
EZE 3:19 But if yu warn wiked pesin and e still dey sin, e go die as sina, but nor bi yor fault.
EZE 3:20 “If betta pesin kon start to do wiked tins and I kause wahala for am, e go die if yu nor warn am. E go die bikos of en sins; I nor go remember di good tins wey e do and I go whole yu for en deat.
EZE 3:21 But if yu warn am make e nor sin, e go get life and yu yorsef go dey save from my vexnashon.”
EZE 3:22 I feel God hand for my body and E kon tell mi, “Get up make yu go di valley, so dat I go tok to yu for der.”
EZE 3:23 So I go di valley and for der, I si God glory, just as I si am near Chebar River. So I fall face groun
EZE 3:24 and God Spirit enter my body kon raiz mi up. Den God tell mi, “Make yu go lock yorsef inside yor house.
EZE 3:25 Man pikin, dem go tie yu with rope and yu nor go fit go out for publik.
EZE 3:26 I go klose yor mout and yu nor go fit tok or warn all doz bad pipol.
EZE 3:27 Den wen I tok to yu again kon give yu di pawa to tok, yu go tell dem wetin mi wey bi God tok. Some of dem go listin, but some nor go listin to wetin yu dey tok, bikos na bad pipol full der.”
EZE 4:1 God sey, “Man pikin, make yu take one stone kon put am for yor front den draw Jerusalem put.
EZE 4:2 Tie am well-well! Make wall round am, den guide am with sojas and betta iron gate.
EZE 4:3 Make yu take one iron pan kon set am up like wall between yu and di town. Den turn make yu face Jerusalem to show sey dem nor go fit eskape wen dia enemies dey kom distroy dem. Dis go bi warnin to Israel pipol.
EZE 4:4 “Den, sleep with yor left side kon put Israel sins on-top yor body. And for di days wey yu take sleep with yor left side, Israel pipol sin go dey yor head.
EZE 4:5 Na mi know di nomba of days wey yu go bear dia sins rish and na three hundred and ninty days wey go ripresent di years wey dem don sin.
EZE 4:6 “Wen yu don komplete dis days, yu go sleep again, but dis time, yu go sleep with di rite and Judah sins go dey yor head. I don sey dis one go bi forty days. One day go ripresent one year.
EZE 4:7 Yu go turn face where yu tie di iron pan put kon tok against am sey;
EZE 4:8 Look! I go tie yu with rope, so dat yu nor go turn anyhow until di days don komplete.
EZE 4:9 “Naw, take some bread, beans, lentil, millet and korn kon put dem for one kontaina, den make yu chop from dem. Na di same days wey yu take sleep, yu go take chop and na three hundred and ninty days.
EZE 4:10 Evriday, di food wey yu go chop must nor heavy pass half pound and make e bi for di same time wey use choose.
EZE 4:11 And na one and half lita of wota yu go dey drink evriday.
EZE 4:12 Yu go use dry human being shit take make fire where yu go take bake di bread wey yu go dey chop evriday and na for where evribody go for si yu.”
EZE 4:13 God still sey, “Dis na to show how Israel pipol go chop food wey dia law sey make dem nor chop. Dat time, I go don skata dem go difren place.”
EZE 4:14 But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”
EZE 4:15 So God sey, “Okay! I go allow yu use melu shit, instead of human being own.”
EZE 4:16 God still sey, “Man pikin, I go remove bread from Jerusalem. Di pipol go dey measure di food and wota wey dem dey drink, so dat e nor go finish.
EZE 4:17 Dia bread and wota go finish; dem go dey for pain and dem go die finish, bikos of dia sin.”
EZE 5:1 God sey, “Man pikin, use sharp knife take kut yor hair and bear-bear. Put di hair for skale kon divide am into three part.
EZE 5:2 Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem.
EZE 5:3 Make yu keep and tie some of di hair for yor klot.
EZE 5:4 Yu go still take some kon trow dem for fire make dem burn. From der, one fire go spread go all Israel family.
EZE 5:5 “Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Na Jerusalem bi dis; I put am for difren nashon centre and difren kountries dey round am.
EZE 5:6 But Jerusalem nor do wetin I kommand and e show sey e wiked pass di oda nashons. E disobey mi pass all di kountries wey dey round am. Jerusalem rijet my kommand and e nor gri receive my laws.
EZE 5:7 “So Jerusalem pipol make una listin: Na mi bi Oga God! Una nor gri obey my laws or tishings, instead una dey do wetin di oda nashons dey do. Una even sturbon pass di tribes wey dey near una.
EZE 5:8 “So mi God dey tell una sey I dey against una. Naw, all doz nashons go dey look as I dey ponish una, bikos una don bi my enemy.
EZE 5:9 Bikos of all di tins wey una do; tins wey I hate well-well. So I go ponish Jerusalem as I neva do before, but I nor go ponish dem like dat again.
EZE 5:10 Bikos of dis, for Jerusalem, papa and mama go chop dia pikin and shidren go chop dia papa and mama. I go ponish una and doz wey go remain wey nor die, I go skata dem for evriwhere for dis world.
EZE 5:11 “So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.
EZE 5:12 Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.
EZE 5:13 So my vexnashon go end and my ponishment go rest for dia head, den I go dey okay. Wen all dis tins don happen, una go si, undastand and know sey na mi God, tok to una.
EZE 5:14 “All di pipol wey dey di oda nashons near una, wen dem waka pass, dem go dey laf and fool una, bikos of how God take distroy una land.
EZE 5:15 Wen I vex kom ponish una, all di nashons near una, go fear. Dem go shake dia head and laf as dem dey look una.
EZE 5:16 I go let honga kill una and una nor go si food chop. Una go feel my vexnashon like arrow wey dem take shot pesin.
EZE 5:17 So, I go send honga and wiked animals kom meet una and dem go kill una shidren. Na trobol and deat go dey una land and I go raiz my swod against una.
EZE 6:1 God tell mi sey,
EZE 6:2 “Man pikin, look where Israel mountin dey, make yu tok against dem.
EZE 6:3 Tell di mountin for Israel sey make e hear wetin God dey tok; make e hear wetin mi di God wey get pawa dey tok. I dey tell di mountin, hills, river and di valley sey: I go send swod go distroy di place where pipol for dey woship juju.
EZE 6:4 I go skata di juju kon broke dia incense altar. I go kill all di pipol for dia juju front.
EZE 6:5 I go skata Israel pipol dead body for evriwhere; I go skata dia bones round di altar.
EZE 6:6 I go distroy all di towns for Israel kon skata dia juju and en altars, den evritin wey dem make, go disappear.
EZE 6:7 I go kill pipol for evriwhere and doz wey go remain, go know sey, na mi bi God.
EZE 6:8 “I go let some of dem eskape di kilin, but I go skata dem go difren kountries
EZE 6:9 where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do.
EZE 6:10 Dem go know sey na mi bi God and I mean am wen I sey I go distroy dem.”
EZE 6:11 God still sey, “Make yu klap yor hand! Mash di groun well-well! Cry with pain kon sey, ‘Bikos of all di wiked and bad tins wey Israel pipol don do, dem go die for war or honga and diziz go kill dem trowey.
EZE 6:12 Doz wey dey stay far, na sickness go kill dem; doz wey dey here go die for war; doz wey survive, na honga go kill dem. Dem go feel how my vexnashon strong rish.
EZE 6:13 Dead body go skata round dia juju and en altars; both for dia hill and on-top evry mountin, under evry green tree and evry oak tree and for evriwhere wey dem for dey burnt sakrifice give dia juju. Dat time, evribody go know sey na mi bi God.
EZE 6:14 Yes, I go vex distroy dia land. I go make dia land empty and from sout, e go bi like desert go rish Diblah town for nort. Yes! E go bi like dat for evriwhere wey dem dey stay. Dat time, dem go know sey na mi bi God.’ ”
EZE 7:1 God tell mi,
EZE 7:2 “Man pikin, dis na wetin mi wey bi Oga God dey tell Israel pipol. Di end don rish for evriwhere for di land!
EZE 7:3 Una end don kom. Una go feel my vexnashon, bikos I dey judge una akordin to wetin una do. I go pay una back for all di bad-bad tins wey una don do.
EZE 7:4 I nor go leave or sorry for una. I go ponish una for di bad tins wey una do, so dat una go know sey na mi bi God.”
EZE 7:5 Dis na wetin God wey get pawa tok: “Israel pipol, I go ponish una well-well.
EZE 7:6 E don finish for una. Na una end bi dis. Una own don finish.
EZE 7:7 Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.
EZE 7:8 E nor go tey before una go feel as my vexnashon strong rish. I go judge una akordin to wetin una do and I go pay una back for all di wiked tins wey una do.
EZE 7:9 I nor go sorry for una or show una mesi. I go ponish una for di bad tins where una don do, den una go know sey na mi bi God and na mi dey ponish una.”
EZE 7:10 Si! Di day for strong wahala dey kom. Trobol go take-ova evriwhere and pipol go dey karry body anyhow.
EZE 7:11 Wahala don turn swod wey go ponish wiked pipol. Nor of dia tins go remain: dia money, propaty, happiness and glory, all of dem go vanish.
EZE 7:12 Di time don rish! Di day don kom. Naw, doz wey dey buy nor dey happy and make doz wey dey sell, mourn, bikos God go ponish evribody.
EZE 7:13 Doz wey dey sell nor go get dia money back wen dem still dey alive, bikos God vexnashon na for all of dem. All dis sinnas go die finish and nobody go remain.
EZE 7:14 Even doh sey dem blow di trumpet and all di sojas for Israel dey ready, nor of dem go gri go fight, bikos I dey vex for all of dem.
EZE 7:15 Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.
EZE 7:16 Some of dem go run go di mountin like doves wey run from valley. All of dem go kry, bikos of dia sins.
EZE 7:17 Evribody hand go dey weak and dia legs go dey shake.
EZE 7:18 Dem go wear sak as klot for body and dem go dey fall as dem dey waka. Dem go skrape dia head and na shame go follow dem.
EZE 7:19 Dem go trowey dia gold and silva for di street like sey na dirty, bikos gold or silva nor go fit save dem wen God vexnashon go kom and dem nor go fit use am get wetin dem wont or chop am like food and na dis gold and silva make dem sin.
EZE 7:20 Before-before, dem dey make yanga with dia fine-fine tins kon take di tins do juju. So na bikos of dis, God make dia money and propaty dey yuzles.
EZE 7:21 God sey, “I go let strenjas tif am from dem and pipol wey nor dey obey di law, go take all dia gold kon spoil am.
EZE 7:22 I nor go tok wen tif dey distroy and rob my temple.
EZE 7:23 So make dem prepare to shain my pipol, bikos na dead body full di land and na wahala full di town.
EZE 7:24 Di pipol wey bad pass, I go bring and let dem tif una house. Una men wey get pawa go run with fear wen I allow pipol kon skata where una for dey woship.
EZE 7:25 Trobol dey kom. Una go look for peace, but una nor go si am.
EZE 7:26 One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.
EZE 7:27 Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”
EZE 8:1 Six years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di sixt mont, di leaders for Judah kom meet mi for my house and at wons God Spirit kon enter my body.
EZE 8:2 I si one vishon and di tin wey I si bi like human being. From en waist go down, e bi like fire wey dey burn, while from di waist kom up, e dey shine like bronze wey dem polish.
EZE 8:3 Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.
EZE 8:4 For der, I si God glory, just as I don si am before wen I dey Chebar River.
EZE 8:5 God kon tell mi, “Man pikin, look go di nort side.” I look and for der near di altar, I si di juju wey dey make God vex.
EZE 8:6 God tell mi, “Man pikin, yu si wetin dem dey do so? Si di yeye tins wey Israel pipol dey do for here! Dem dey porshu mi komot from my Holy Place. Yu go even si tins wey bad pass dis ones.”
EZE 8:7 So, E take mi go di gate for di kourtyard kon show mi di hole wey dey di wall.
EZE 8:8 Den E sey, “Man pikin, break di wall.” I break am and I kon si one door.
EZE 8:9 E tell mi, “Go inside make yu si di bad and wiked tins wey dem don do for der.”
EZE 8:10 So I kon go look. Dem draw snake with oda bad animals and all dia juju for di wall.
EZE 8:11 Seventy Israel leaders dey der, plus Jaazanaya wey bi Shafan pikin. Each of dem whole wetin dem take dey burn incense and smoke dey kom out from am.
EZE 8:12 God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
EZE 8:13 Den God tell mi, “Yu go si sey dem dey do tins wey even bad pass dis ones.”
EZE 8:14 So E take mi go di nort gate for di temple kon show mi wimen wey dey kry, bikos of dia juju, Tammuz.
EZE 8:15 E kon ask mi, “Man pikin, yu dey si dat one so? Yu go si di ones wey worse pass dis one.”
EZE 8:16 So E take mi go inside di kourtyard for di temple. Near di Holy Place gate wey dey near di altar and di varanda, twenty-five men dey der. Dem back di Holy Place kon dey bow face di east, dey woship di sun as e dey raiz.
EZE 8:17 God kon tell mi, “Man pikin, yu dey si dat one too? All dis bad tins wey Judah pipol dey do and wey don spread for di land, nor do dem, but dem still dey do am for my Holy Place and e dey make mi vex for dem more-more. Si as dem dey curse mi for outside!
EZE 8:18 So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”
EZE 9:1 Den I hear God shaut, “Una wey won go ponish di town, make una bring una gun, swod and knife kom.”
EZE 9:2 At wons, six men just kom out from di nort gate for di temple, each of dem karry swod. E get one man among dem wey wear linen and e whole sometin for hand wey e won take rite. All of dem kon stand near di bronze altar.
EZE 9:3 Den Israel God glory raiz-up from di creatures wey get feada kon move go di temple gate. God koll di man wey wear linen kon tell am,
EZE 9:4 “Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”
EZE 9:5 I hear wen God tell di oda men sey, “Make una follow am pass thru di town kon bigin kill pipol and make una nor sorry or leave anybody.
EZE 9:6 Make una kill both old and yong pipol; weda na papa, mama or pikin. But make una nor tosh anybody wey get di mark for en head. Make una start from my temple.” So dem kon start with di leaders wey dey der.
EZE 9:7 God sey, “Skata di temple! Make dead body full inside! Make una start to kill!” So dem start to kill di pipol wey dey for di town.
EZE 9:8 Na only mi dey der wen dem start to kill. So I fall face groun kon shaut, “Oga God wey get pawa well-well, na so Yu dey vex for Jerusalem? Yu wont kill evribody wey dey Israel?”
EZE 9:9 God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
EZE 9:10 But I nor go sorry for dem. Na wetin dem do oda pipol, na di same tin I go do dem.”
EZE 9:11 Den di man wey wear linen klot, kom back kon tell God sey, “I don do as Yu sey make I do.”
EZE 10:1 I look on-top di creatures wey dey alive kon si sometin wey bi like throne wey dem make with safaya.
EZE 10:2 So God tell di man wey wear linen sey, “Go under di wheel make yu pak shako full hand kon go pour am for di town.” So, I look am as e dey go.
EZE 10:3 As di man go inside, di creatures stand face di sout-side for di temple and kloud kon full inside di kourtyard.
EZE 10:4 God glory kon raiz-up from di creatures and E move go di temple gate. Den kloud full di temple and di kourt kon dey shine, bikos of di lite.
EZE 10:5 Pipol wey dey outside di kourtyard dey hear di nois wey di creatures feada dey make and e bi like sey na Oga God dey tok.
EZE 10:6 Wen God sey make di man wey wear linen go take fire from under di wheel, di man go inside go stand near one of di wheel.
EZE 10:7 One among di creatures kon put en hand inside di fire, pak some shako, den e put am for di man hand. Di man take di shako kon komot der.
EZE 10:8 I si sey di creatures get sometin wey bi like human being hand under dia feada.
EZE 10:9 I still si sey dem get four wheel wey bi like each oda and each wheel dey near en creature.
EZE 10:10 And wen I look dem well: di four wheel resemble each oda like sey dem get wheel inside dia wheel.
EZE 10:11 Di creatures fit go anywhere without sey dem turn. Dem dey go di direcshon wey dem like without sey dem turn.
EZE 10:12 Eyes dey evriwhere for dia body, back, hand, feada and wheel.
EZE 10:13 I hear as dem dey koll dia wheel, “O wheel.”
EZE 10:14 Each creature get four face. Di first one face na, angel own, di sekond one, na human being own, di third one, na lion own and di fourt one, na eagle own.
EZE 10:15 (Dem bi di same creature wey I si for Chebar River.) Wen di creature get up
EZE 10:16 kon move, di wheel follow dem. Even wen dem won fly, di wheel dey follow dem fly too.
EZE 10:17 Wen dem stop, di wheel stop too and wen di creature fly again, di wheel follow dem, bikos na di creatures dey kontrol di wheel.
EZE 10:18 Den God glory komot from di temple gate kon go where high pass where di creatures dey.
EZE 10:19 Dem spread dia feada kon fly komot di eart and I dey look as di wheel follow dem. Dem stop for di east gate for di temple and Israel God glory kon kover dem.
EZE 10:20 I si dem as di same creatures wey I bin si under Israel God for Chebar River. I know sey dem bi angel.
EZE 10:21 Each of dem get four face, four feada and sometin wey bi like human being hand, dey under dia feada.
EZE 10:22 Dia face just bi like di face wey I si for Chebar River. Each creature just dey waka strait dey go.
EZE 11:1 God Spirit kon karry mi go di east gate for di temple. For near di gate, I kon si twenty-five men, plus Jaazanaya, wey Azzur born and Pelataya wey bi Benaya pikin and di two of dem na leaders for di land.
EZE 11:2 So God tell mi, “Dis men dey plan evil and na wiked advise dem dey give Jerusalem pipol.
EZE 11:3 Dem sey, ‘E neva rish wen wi go ribuild awa house. Di town bi like pot and na wi bi di meat wey dey inside di pot, but at least di fire nor dey tosh or burn us.’
EZE 11:4 So, Man pikin, go tok against wetin dem dey do.”
EZE 11:5 God Spirit kon dey kontrol mi and E give mi message make I go tell Israel pipol sey: “I know wetin una dey tok and wetin una dey plan to do.
EZE 11:6 Una don kill many pipol for dis town, sotey dead body don full evriwhere for di street.
EZE 11:7 So dis na wetin mi God dey tell una. ‘I gri sey di town na pot and na pipol wey una kill bi di meat! So, una nor go stay here again, bikos I go remove una from di town!
EZE 11:8 Shebi una dey fear swod? So, I go fight una with men wey karry swods.
EZE 11:9 I go take una komot di town kon give una to strenjas. Yes! I go judge una
EZE 11:10 and una go die wen una dey fight war for una kountry. Den evribody go know sey na mi bi God.
EZE 11:11 Dis town nor go bi pot for una again and una nor go bi meat inside am. So, anywhere wey una dey for Israel, I go judge and ponish una.
EZE 11:12 Den una go know sey na mi bi God! Una dey keep oda nashon law, but una dey break my own and nor dey obey my kommand.’ ”
EZE 11:13 As I still dey tok, Pelataya wey bi Benaya pikin, kon fall die. I fall face groun kon shaut, “God wey get pawa well-well, nor bi so o-o! Yu won kill evribody wey remain for Israel?”
EZE 11:14 God kon tell mi:
EZE 11:15 “Man pikin, di pipol where dey Jerusalem dey tok about yu and di odas wey dey for strenjas land. Dem dey sey, ‘Doz wey dey dem karry go Babilon nor go fit woship God, bikos of where dem dey. So God don give us di land.’
EZE 11:16 “Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.
EZE 11:17 “So, make yu tell dem wetin mi wey bi God dey tok. I go gada dem kom back from di land where I skata dem go kon give dem Israel land again.
EZE 11:18 “Wen dem kom back, dem must skata all di rubbish tins wey dem dey do before kon skata any juju wey dem si for der.
EZE 11:19 I go give dem new heart and mind. I go komot dia sturbon heart wey bi like stone kon put anoda heart wey dey gentol and dey obey.
EZE 11:20 Dat time, dem go keep my law and obey my kommand with all dia heart. Dem go bi my pipol and I go bi dia God.
EZE 11:21 But pipol wey still like to woship juju and do bad tins, I go ponish dem. I go ponish dem for di tins wey dem don do.”
EZE 11:22 Di creatures kon dey fly and di wheel follow dem too.
EZE 11:23 God glory kon komot di town go di east side for di mountin.
EZE 11:24 Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon. Den di vishon kon finish
EZE 11:25 and I tell di pipol evritin wey God don show mi.
EZE 12:1 God kon tell mi.
EZE 12:2 “Man pikin, na where sturbon pipol der yu dey stay. Dem get eye, but dem nor dey si; dem get ear, but dem nor der hear, bikos dem sturbon well-well.
EZE 12:3 “So man pikin, make yu pak yor load like sey yu dey komot di town. For aftanoon wen pipol still dey look, pritend like sey yu dey go Babilon. Komot from where yu dey kon go anoda place. May bi dia mind go tell dem wetin dey happen, even doh dem sturbon well-well.
EZE 12:4 For aftanoon wen dem still dey look yu, karry di tins wey yu pak like sey yu dey go Babilon. Wen dem still dey look yu, komot der for evening like sey yu dey go anoda place.
EZE 12:5 Break di wall open as dem dey look yu kon trow yor load pass am.
EZE 12:6 As dem still dey look yu, karry yor load for shoulder, den make yu waka enter darkness. Yu must kover yor face, so dat yu nor go si di land and dis go bi warnin to Israel pipol.”
EZE 12:7 So, I do as God kommand mi. For day time wen dem dey look mi, I pak my load kon karry am like sey I dey go Babilon and for evening, I break di wall with my hand. Den I go out for nite kon karry my load for shoulder and dem still dey look mi.
EZE 12:8 For morning, God kon tell mi:
EZE 12:9 “Man pikin, naw wey dem don dey ask yu wetin yu dey do,
EZE 12:10 make yu tell dem wetin mi wey bi God tell yu. ‘Dis message na for di priest wey dey rule for Jerusalem and for all di pipol wey dey stay der.’
EZE 12:11 Tell dem sey, ‘I bi warnin to una. Just as I don do, na so too God go do una. Dem go katch and karry una go Babilon as slaves.’
EZE 12:12 “Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.
EZE 12:13 Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die.
EZE 12:14 So I go skata en ofisas and sojas go difren place and mi God go katch and kill dem.
EZE 12:15 “Wen I don skata dem among di nashons and for strenja land, den dem go know sey na mi bi God.
EZE 12:16 But I go let some of dem survive di war, honga and diziz, so dat dem go tell di nashon where dem dey stay naw, about all di yeye tins wey dem do. Den, dem go know sey na mi bi God.”
EZE 12:17 God still tell mi sey:
EZE 12:18 “Man pikin, kry as yu dey chop yor food. Dey shake as yu dey drink wota.
EZE 12:19 Den make yu tell di pipol for di land sey, ‘Dis na wetin God tok about una wey dey stay for Jerusalem and Israel. Una go chop una bread with pain kon drink wota with fear. Bikos of di wahala wey una kause, I go take evritin wey dey una land.
EZE 12:20 Pipol wey dey stay der go sofa and di land go skata finish. Den, una go know sey na mi bi God.’ ”
EZE 12:21 Den God tell mi:
EZE 12:22 “Man pikin, wetin make Israel pipol dey always tok like dis: ‘Di days dey pass dey go, yet all dis vishons nor mean anytin to dem?’
EZE 12:23 So make yu tell dem sey: ‘Dis na wetin God wey get pawa tok: I go stop all di word wey di pipol dey tok and dem nor go tok like dis for Israel again.’ But make yu tell dem, ‘Di day don rish wen evry vishon wey dem tok, go happen.
EZE 12:24 Bikos dat time, di yeye vishon or words wey Israel pipol dey tok, nor go dey again.
EZE 12:25 Bikos mi wey bi God go tok anytin wey I like and e go happen, just as I tok am: E nor go waste time again and na wen wiked pipol still dey alive. Yes! I go tok di word and e go happen just as I tok am.’ ”
EZE 12:26 Den God tell mi:
EZE 12:27 “Man pikin, Israel house dey sey, ‘Di vishon wey God dey tell us nor go happen naw; E dey tok about tin wey go happen tumoro.’
EZE 12:28 So make yu tell dem, ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Evritin wey I tok, nor go tey before dem go happen! Evry word wey I tok, go must happen.’ ”
EZE 13:1 God tell mi:
EZE 13:2 “Man pikin, make yu tok against di profets for Israel. Profets wey dey tell pipol anytin wey dem like. Go tell dem sey: ‘Make una hear God word!
EZE 13:3 God wey get pawa sey: E nor go betta for foolish profets wey dey follow dia own spirit, even wen dem neva si anytin at-all!
EZE 13:4 Israel pipol, una profets dey yuzles like animals wey dey inside dirty for di town.
EZE 13:5 Since dem nor gri guide di place where di wall for break or ribuild am, nor-tin go fit guide Israel pipol wen God wahala go kom.
EZE 13:6 Dia vishon na lie and anytin wey dem tok sey go happen, nor dey happen. Dem dey sey na my message dem dey prish, but I nor send dem and dem dey espect sey wetin dem tok, go happen!
EZE 13:7 I tell dem sey all doz vishon wey dem si, na lie dem bi and evritin wey dem sey go happen, nor go happen. Una sey na my word, but I neva follow una tok anytin wons!’ ”
EZE 13:8 Den God kon tell mi: “Una words na lie and una vishons nor go happen. I really dey vex for una.
EZE 13:9 I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
EZE 13:10 “Di profets deceive my pipol wen dem tell dem sey evritin dey okay. But evritin nor dey okay at-all! My pipol don build wall with stones wey nor strong and di profets kon paint am fine for dem.
EZE 13:11 So make yu go tell di profets sey dia wall go fall. I go send rain with big-big stone kon fall on-top am and betta strong breeze go blow am trowey.
EZE 13:12 Wen di wall don fall, pipol go ask di profets, ‘Wetin happen to di wall wey una paint?’ ”
EZE 13:13 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “As I dey vex, I go send strong breeze with rain and big-big stone kon skata di wall.
EZE 13:14 I go break di wall wey dem paint and evritin go skata finish. E go fall kon kill evribody, den una go know sey na mi bi God.
EZE 13:15 Di wall plus doz wey paint am, go si how my vexnashon strong rish. Den I go tell una sey di wall and doz wey paint am, don skata
EZE 13:16 and dem bi doz profets wey tell Jerusalem pipol sey evritin dey okay, wen evritin nor dey okay!”
EZE 13:17 Den God tell mi: “Naw, make yu si di lie-lie wimen wey dey among una. Tell dem
EZE 13:18 wetin God tok about dem sey: ‘Una wey dey put odas life for danger, ponishment dey wait una. Una tie majik for dia hand and give dem majik klot wear. Una tink sey una fit trap odas without sey una nor go sofa too?
EZE 13:19 Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”
EZE 13:20 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I know like dat rope wey dey una hand wey una dey use take kontrol pipol life. I go remove dem from una hand kon free doz wey una dey kontrol.
EZE 13:21 I go komot una priest kap kon let my pipol free from una hand wons and for all. Den una go know sey na mi bi God.
EZE 13:22 Una dey use una lie take diskorage good pipol; pipol wey I nor like to ponish. Una nor let evil pipol shange from di bad tins wey dem dey do, so dat dem go dey save.
EZE 13:23 So una lie-lie vishon, don end. I go save my pipol from una pawa, so dat una go know sey na mi bi God.”
EZE 14:1 Some leaders for Israel kom meet and ask mi sey, “Wetin God wont?”
EZE 14:2 So God tell mi:
EZE 14:3 “Man pikin, dis pipol don give dia heart to juju and na di juju dey make dem sin. Dem tink sey I go ansa dem?
EZE 14:4 Naw, go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: Israel pipol dey serve juju and dis juju don make dem dey sin; so if dem go ask any profet kweshon, na mi God go give dem di kind ansa wey good for dia many juju!
EZE 14:5 All dis juju don make Israel pipol turn from mi, but afta I don ansa dem, I bilive sey dem go turn back kom meet mi.
EZE 14:6 “Naw, make yu tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tok: Make una turn back from una juju and from di yeye life wey una dey live.
EZE 14:7 Wen ever any Israel pesin or strenja for Israel turn leave mi kon go serve juju, den e go ask profet kweshon, na mi wey bi God, go ansa am!
EZE 14:8 I go oppoz am. I go use am make ezample for odas. I go komot am from among my pipol. Den una go know sey na mi bi God.
EZE 14:9 “If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.
EZE 14:10 Both di profet and di pipol wey ask am kweshon, na di same ponishment I go give dem too.
EZE 14:11 I go do like dis, so dat Israel pipol go obey and dem nor go turn from mi. Dem suppose bi my pipol and I go bi dia God.”
EZE 14:12 Den, God kon tell mi:
EZE 14:13 “Man pikin, if one kountry sin kon disobey mi, I go stop to give dem food chop. I go send betta honga go der kon kill both animal and human being.
EZE 14:14 Even if Noah, Daniel and Job dey stay der, dia good wey dem dey do, go save only dia own life.”
EZE 14:15 “Or I fit send wiked animal make e kom kill di pipol, den evribody go dey fear di land; nobody go fit travel pass am
EZE 14:16 and even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren. Dem go save only dia life and di land go bi like wildaness.
EZE 14:17 “Or I fit send war kom dat kountry and dem go distroy di pipol and dia animals with gun, swods and knife
EZE 14:18 and even if doz three men dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, na only dia own life dem go save.
EZE 14:19 “If I send betta diziz go dat kountry kon kill many pipol and animals, bikos I dey vex
EZE 14:20 even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, di betta tins wey dem do, go only save dia own life.”
EZE 14:21 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
EZE 14:22 Yet some pipol go survive for di town, both sons and dotas and dem go karry dem as prisonas go Babilon and wen yu si as dem sin rish, yu go know why I do all dis tins.
EZE 14:23 Yu go si di real rizin why I dey do wetin I dey do.”
EZE 15:1 Den, God kon tell mi:
EZE 15:2 “Man pikin, na how dem won take kompare vine with tree for forest?
EZE 15:3 Yu fit use di vine do anytin? Yu fit even hang sometin on-top am?
EZE 15:4 E only dey yuzful as firewood. Even if di wood nor burn skata finish for di fire, yu still fit use am do anytin?
EZE 15:5 E nor bin dey yuzful even before dem burn am, so na naw wey fire don burn am, e won dey yuzful?”
EZE 15:6 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy
EZE 15:7 and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God.
EZE 15:8 Dem nor dey respet mi, so I go turn dia land to desert.”
EZE 16:1 God kon tell mi again sey:
EZE 16:2 “Man pikin, go meet Jerusalem pipol about di bad tins wey dem do kon tell dem sey
EZE 16:3 ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tell Jerusalem: “Na Kanaan land dem for born yu. Yor papa kom from Amor and yor mama na from Hit.
EZE 16:4 Wen dem born yu, nobody kut di rope wey join yu and yor mama togeda or sey dem wosh and rub yu with salt or wrap yu put inside klot.
EZE 16:5 Nobody sorry for yu kon do any of dis tins for yu. Wen dem born yu, nobody love yu and dem trowey yu for open field.
EZE 16:6 “ ‘ “Den wen I dey pass, I si yu dey roll for inside yor own blood for groun. Blood kover yor full body, but I nor fit look make yu dey die.
EZE 16:7 So I make yu grow like betta seed wey dem plant. Yu strong as yu dey grow and yu tall like fine woman. Yor breast dey okay and yor hair fine well-well, but yu dey naked.
EZE 16:8 “ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ”
EZE 16:9 “Leta, I take wota wosh di blood komot yor body kon rub olive oil for yor skin.
EZE 16:10 I dress yu with klot wey dem design well kon give yu shoe wey dem make with betta leader, den I put priest kap wey dem make with linen for yor head.
EZE 16:11 I still wear jewel and difren shains for yor neck.
EZE 16:12 I give yu one nose ring, ear-ring and one fine crown make yu wear.
EZE 16:13 Yu get difren gold and silva and yu always dey wear klot wey dem make with betta linen and silk. Yu dey chop bread wey dem make with di best flower and yu get many honey and olive oil to drink. Yor beauti dey shine and yu bi kween.
EZE 16:14 Bikos of di wey yu fine rish, evribody know yu for evriwhere, bikos na mi make yu fine well-well.
EZE 16:15 “Bikos yu fine, yu kon bigin do anyhow and dey sleep with anybody wey yu si.
EZE 16:16 Yu design di place where yu for dey woship yor juju with yor klot like sey na ashawo house and yu kon dey sleep with evribody for der.
EZE 16:17 I give yu fine silva and gold make yu dey wear, but naw, yu don use dem make juju wey yu dey sleep with.
EZE 16:18 Yu take di fine-fine klot wey I give yu kon wear dem give di juju and di olive oil wey I give yu, yu still dey offa am give di juju.
EZE 16:19 I give yu food; di best flower, olive oil and honey, but yu sakrifice dem give di juju sey, Make yu protet mi.”
EZE 16:20 “Den di shidren wey yu born for mi, yu sakrifice dem give di juju too. Like sey di ashawo wey yu dey do nor bad rish,
EZE 16:21 yu still go sakrifice my shidren give juju.
EZE 16:22 Even as yu dey do ashawo waka, yu nor remember di days wen yu dey small, naked for groun and dey roll for yor blood.”
EZE 16:23 God sey, “Si di kind sofa wey dey wait yu bikos of yor many evil and as
EZE 16:24 yu build where dem go for woship yor juju for evry street for di town.
EZE 16:25 Yu trowey yor beauti for portor-portor, bikos anybody wey kom meet yu, yu dey sleep with am and yor ashawo dey strong evriday.
EZE 16:26 Yor ashawo friends wey kom from Egypt, yu let dem sleep with yu and naw, yor ashawo life dey make mi vex.
EZE 16:27 Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.
EZE 16:28 Bikos nor-tin dey rish yu, yu kon dey follow Assyria pipol. Even doh yu bi dia ashawo, dem nor still dey okay for yu.
EZE 16:29 Yu still bi ashawo for Babilon wey get business men, but dem nor rish yu too.”
EZE 16:30 So dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu don do all dis tins like ashawo wey nor get shame for eye.
EZE 16:31 For evry street, yu build where pipol go for dey woship juju and learn ashawo. But yu still betta pass ordinary ashawo, bikos yu get money.
EZE 16:32 “Yu bi like wife wey nor love en husband, instead e dey sleep with strenjas anyhow.
EZE 16:33 Pipol dey pay ashawo, but yor own difren, bikos na yu dey give pipol gift make dem for kom sleep with yu.
EZE 16:34 Yor ashawo dey difren, bikos nobody sey yu must bi ashawo. Nobody dey pay, instead na yu dey pay dem! True-true, yor ashawo dey difren.”
EZE 16:35 So, Jerusalem, make yu hear mi naw! Hear wetin God dey tok.
EZE 16:36 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu tear yor klot komot body kon give yor body to yor lovers dem and all yor juju, den yu kill and sakrifice yor shidren give juju too.
EZE 16:37 Bikos of dis, I go bring all di pipol wey yu love togeda; di ones wey yu like and doz wey yu hate. Dem go round yu like circol, den I go tear yor klot komot yor body kon let dem si yor nakednes.
EZE 16:38 I go distroy yu, bikos of yor ashawo life and doz wey yu kill. Den with my vexnashon, I go ponish yu till yu die.
EZE 16:39 I go put yu for dia hand and dem go skata di place where yu for dey serve juju and do ashawo. Dem go take yor klot and gold go and yu go dey naked.
EZE 16:40 Dem go gada crowd kon stone yu, den dem go use dia swod take kut yu to pieces.
EZE 16:41 Dem go burn yor house and many wimen go si as dem dey ponish yu. I go make yu stop ashawo work and doz wey love yu, yu nor go give dem gift again.
EZE 16:42 Den I nor go vex again and I go kwayet. I nor go dey vex or jealous again.
EZE 16:43 “Since yu don forget how I kare for yu wen yu bi small pikin and yu don make bi vex with all di tins wey yu dey do, I must pay yu back for all dis bad tins. But, wetin make yu dey do ashawo join di bad-bad tins wey yu do?”
EZE 16:44 God sey, “Jerusalem, pipol go use dis tins take tok about yu: ‘Like mama, like pikin.’
EZE 16:45 Yu really bi yor mama pikin. Yor mama run leave en husband and shidren. Yu bi like yor sista wey hate en husband and shidren too. Yu and Hit wey bi di oda town get di same mama and na Amor bi una papa.
EZE 16:46 Yor senior sista na Samaria for nort. Yor yonga sista na Sodom for sout.
EZE 16:47 Yu like as yu dey do di bad tins wey dem do? No! But e nor even tey before yor own worse pass dia own.
EZE 16:48 So as long as mi wey bi God dey alive, I dey sey, ‘Yor sista, Sodom and en village nor ever do di wiked tins wey yu and yor village don do.’
EZE 16:49 “Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
EZE 16:50 Dem proud and sturbon kon dey do tins wey I nor like and na dis make mi distroy dem, just as all of yu know.
EZE 16:51 Samaria nor do half of di bads tins wey yu do. Yu ways bad well-well pass dia own. Bikos of di bad tins wey yu dey do, e kon bi like sey yor sistas nor even do any bad tin at-all.
EZE 16:52 So naw, make yu bear di shame wey dey kom. Yor sins bad pass yor sistas own, sotey if dem look yu, dem go sey, ‘Wi nor even do anytin.’ Naw, make yu bear yor shame and pain, bikos yu don make yor sistas bi like good pesin.”
EZE 16:53 God tell Jerusalem, “Sodom and Samaria town, I go make una grow and prosper again.
EZE 16:54 Yu go shame for yorsef and yor disgrace go show yor sistas sey dem even dey good pass yu.
EZE 16:55 But wen di time don rish, I go make dem prosper again and I go ribuild yu and yor town.
EZE 16:56 Dat time wey yu dey proud, shebi yu dey laf Sodom
EZE 16:57 wen yor wikedness neva bring yu kom out? Naw, yu just bi like am, bikos Edom, Filistia pipol and yor neighbours wey hate yu, dey laf yu naw.
EZE 16:58 Yu must sofa for all di wiked and bad tins wey yu don do.”
EZE 16:59 God kon sey, “Na as I suppose trit yu, I go trit yu, bikos yu nor gri do wetin yu promise and yu break di kovenant.
EZE 16:60 But I go still do di kovenant wey I make with yu wen yu dey small. I go make kovenant with yu wey go last forever.
EZE 16:61 Yu go remember how yu bihave, den shame go katch yu wen yor senior and yonga sista go kom back kon meet yu. I go let dem bi like yor pikin.
EZE 16:62 I go renew my kovenant with yu and yu go know sey na mi bi God.
EZE 16:63 I go forgive yu all di bad tins wey yu don do, but wen yu remember dem, shame nor go let yu open yor mout.”
EZE 17:1 God kon tell mi:
EZE 17:2 “Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;
EZE 17:3 tell dem sey di Oga God wey get pawa well-well sey: “One big eagle wey get fine and long feadas, fly go Mount Lebanon kon break di branches wey high pass for one cedar tree komot,
EZE 17:4 den e karry am go where pipol for dey do business kon plant am for der.
EZE 17:5 E take one small plant for Israel kon go plant am for betta groun and wota dey always dey di place so dat e go grow.
EZE 17:6 So di plant grow kon spread for evriwhere like grape tree. Di branches dem grow well-well and en rut strong for groun too. E kon turn to big vine tree wey get many branches and leaf.
EZE 17:7 Anoda strong eagle wey get big and tick feada dey. Naw, di rut and leaf for di vine face dis eagle, bikos di vine bilive sey di eagle go gi-am more wota pass di one wey di gardin dey give,
EZE 17:8 even doh dem don already plant di vine for betta groun wey get wota, wey go make am grow well kon bear betta and sweet fruits.
EZE 17:9 Naw, mi God wey get pawa dey ask: Dis vine go prosper? No! I go plok all en fruit kon rut am komot groun and en leaf go dry kon die. I nor nid strong hand or many pipol, bikos e nor go hard mi to rut am from groun.
EZE 17:10 Yes, dem don plant am, but e go fit prosper? E nor go die wen breeze blow kom from east? Abi e nor go dry finish for where e for dey grow?”
EZE 17:11 God tell mi,
EZE 17:12 “Ask dis bad pipol if dem know wetin di parabol mean. Tell dem sey Babilon king kom katch and karry Jerusalem king and en ofisas go Babilon.
EZE 17:13 E choose one of Jerusalem king broda, enter agriment with am kon make am swear sey e go always dey loyal to am. E katch and karry important pipol go prison,
EZE 17:14 so dat Jerusalem nor go raiz again and to make sure sey dem go keep di agriment wey dem make with am.
EZE 17:15 But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?
EZE 17:16 “As long as I bi God wey nor dey die, dis king go die for Babilon, bikos e break di agriment wey e make with Babilon king wey put am for di throne.
EZE 17:17 Wen Babilon sojas don ready to attack and kill pipol, even di sojas wey strong pass for Egypt nor go fit help Judah king, tok-less of to save am,
EZE 17:18 bikos e don break di agriment wey e make. E do all dis tins and naw, e nor go eskape am.”
EZE 17:19 So God wey get pawa sey, “As long as I bi di God wey nor dey die, I go ponish am, bikos e break di agriment wey e make with my name.
EZE 17:20 I go katch am with my net. I go take am go Babilon kon ponish am for der, bikos e disobey mi.
EZE 17:21 Dem go kill en betta-betta sojas for war and di ones wey survive go skata for evriwhere. Den e go know sey,
EZE 17:22 Dis na wetin God dey tok: “I go kut di branches wey high pass for di cedar tree komot, den I go plant am on-top mountin
EZE 17:23 and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.
EZE 17:24 Evry tree for di land go know sey na mi bi God. I go kut di trees wey tall and di ones wey short, I go make dem tall. I go make green trees dry kon make dry trees, green. Mi wey bi God don tok and I go do wetin I sey I go do.”
EZE 18:1 God kon tell mi again sey,
EZE 18:2 “Israel pipol, dis word wey una dey always tok for dis land, na wetin e mean? Una dey sey, “ ‘Mama and papa dey chop grape wey don sawa, but na di shidren dey feel di sawa taste for dia mout.’ ”
EZE 18:3 God sey, “As long as I bi di God wey nor dey die, una nor go tok dis kind tins again.
EZE 18:4 Na mi get evribody life, even una papa and mama plus dia shidren life, na mi get am. Di pesin wey sin, na-im go die.
EZE 18:5 “If to sey one man dey wey really dey good, raitious and honest;
EZE 18:6 nor dey serve Israel pipol juju or chop food wey dem sakrifice give juju:
EZE 18:7 Pesin wey nor dey play pipol wayo or tif from pipol. Anytin wey pesin gi-am, so dat e go borrow di pesin money, e dey riton am give di pesin; e dey give food to pipol wey dey hongry and doz wey dey naked, e dey give dem klot wear.
EZE 18:8 E nor dey borrow pipol money so dat e go get gain. E nor dey do bad tins and e dey judge matter well.
EZE 18:9 Pesin wey dey obey my kommand and keep my laws well. God wey get pawa sey, dat kind man dey raitious and e go get long life.
EZE 18:10 “But if dis man get boy pikin wey dey kill and do all dis bad tins
EZE 18:11 wey en papa nor dey do kon dey chop juju food and sleep with pipol wife?
EZE 18:12 Or dey play poor pipol wayo; dey tif, dey keep wetin pesin gi-am, so dat e go borrow am money; dey follow sinnas go woship dia juju
EZE 18:13 and dey borrow pipol money to make gain. E go fit live? No! E nor go live. E don do all dis bad tins, so e must die and e go blame ensef for en own deat.
EZE 18:14 “But if e born pikin and di pikin si all di sins wey en papa dey do, but e nor follow am,
EZE 18:15 or follow dem serve juju or chop food wey dem sakrifice give juju. Nor dey sleep with anoda man wife,
EZE 18:16 opress or tif from pipol. Dey riton wetin pesin gi-am to take borrow money. Dey feed pipol wey dey hongry kon give klot to doz wey dey naked
EZE 18:17 and nor gri do wiked tins or borrow pipol money to get gain. But dey keep my law and obey my kommand. E nor go die, bikos of en papa sin, but e go get long life.
EZE 18:18 But for en papa wey play wayo, tif and dey wiked to evribody, go die bikos of di sins wey e kommit.
EZE 18:19 “Naw, yu go ask sey: ‘Wetin make di pikin nor sofa for wetin e papa do?’ Di ansa na sey di pikin do wetin dey rite and good. E keep and obey my law, so e must really get long life.
EZE 18:20 Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.
EZE 18:21 “If wiked man stop to sin kon dey obey my law; dey do wetin dey rite and good, e nor go die, but e go get life.
EZE 18:22 God go forgi-am all en sin and e go get life, bikos e do di rite tin.”
EZE 18:23 God wey get pawa sey, “Yu tink sey I dey happy as wiked pipol dey die? No! I go like if dem turn from sin kom meet mi, so dat dem go get life.
EZE 18:24 “But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.
EZE 18:25 “Den una sey, ‘God dey play wayo.’ Naw, Israel pipol, make una ansa mi, ‘I dey play wayo?’
EZE 18:26 Wen betta pesin stop to do good kon dey do bad tin, den e kon die, e die bikos of di sin and wiked tins wey e do.
EZE 18:27 Na so too, wen wiked man stop to sin kon dey do wetin dey rite and good, e go save en life,
EZE 18:28 bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.
EZE 18:29 Una wey bi Israel pipol dey sey, ‘God dey play wayo.’ Una tink sey na wayo I dey do? Nor bi una dey do wayo?
EZE 18:30 “Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.
EZE 18:31 Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?
EZE 18:32 I nor wont make anybody die.” God wey get pawa sey, “Make una run from sin and una go get life.”
EZE 19:1 God sey make I sing dis sorrowful song for di prince dem wey dey Israel:
EZE 19:2 “Una mama na really strong lion wey train en shidren for where oda wiked lions dey.
EZE 19:3 E tish one among en shidren how e go take katch oda animals and naw, e dey chop human being.
EZE 19:4 But pipol for oda nashons hear about am, so dem tie and trow am inside pit kon drag am with hook go Egypt.
EZE 19:5 Wen di mama wait kon si sey en pikin nor dey kom back again, e kon train anoda lion wey wiked pass di first one.
EZE 19:6 Wen dat one don big, e kon start to katch animals and chop human being like oda lions.
EZE 19:7 E skata where sojas dey guide well and distroy dia towns. Di way e dey shaut, dey make di pipol for di land dey fear.
EZE 19:8 Pipol gada kom from evriwhere kon fight am. Dem spread dia net kon katch am with dia trap.
EZE 19:9 Den dem put am for kage kon karry am go give Babilon king. Dem put am for prison, so dat pipol nor go hear en vois again on-top Israel mountin.
EZE 19:10 Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.
EZE 19:11 En branches strong well-well like royal rod. Di vine grow and tall well-well. Yes! Evribody si as e tall rish and how en leaf fine.
EZE 19:12 But wiked pipol kon kut am down. Di wind blow kon dry all en fruit. En branches dem break komot kon dry and fire burn dem.
EZE 19:13 Naw, dem plant am for desert; di place wey dry and nor get wota.
EZE 19:14 Den fire katch di vine kon burn evritin plus en fruit finish and e nor go ever strong again. E nor go ever bi dat royal rod again. “Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”
EZE 20:1 Seven years afta dem karry Israel pipol go Babilon as prisonas, for di tent dey for di fift mont, some leaders for Israel kom my house kon sidan for my front dey ask mi sey wetin God wont.
EZE 20:2 Den God kon tell mi:
EZE 20:3 “Man pikin, tell dis men wetin God wey get pawa dey tok: Una don kom ask wetin I wont, abi? As long as I bi di God wey dey alive, I nor go let una ask mi anytin.
EZE 20:4 “Man pikin, yu don ready to judge dem? Yu don ready to judge all of dem naw? Den, make yu judge dem. Remind dem about all di bad-bad tins wey dia papa don do before.
EZE 20:5 Tell dem wetin I dey tok. Wen I choose Israel, I promise Jakob shidren-shidren kon show mysef and tell dem wen dem dey Egypt sey: ‘Na mi bi di Oga wey bi dia God.’
EZE 20:6 Dat time, I promise sey I go take dem komot from Egypt go di land wey I don choose for dem. Di land wey dey okay, good and e fine well-well.
EZE 20:7 I tell dem sey make dem trowey all dia juju and make dem nor dirty demsef with Egypt juju, bikos na mi bi di Oga wey bi dia God.
EZE 20:8 But dem rijet mi and nor gri listin to mi. Dem nor gri trowey dia juju or stop to woship Egypt gods and naw, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
EZE 20:9 But I nor do am, bikos I nor won disgrace my name. I nor go spoil my name give doz nashons wey si mi wen I dey take my pipol komot Egypt
EZE 20:10 and true-true, I take dem komot Egypt go inside di wildaness.
EZE 20:11 “I give dem my kommand kon tell dem my laws wey dey give life to doz wey obey am.
EZE 20:12 I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.
EZE 20:13 “But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
EZE 20:14 But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.
EZE 20:15 So, I kon swear for dem di wildaness sey, I nor go take dem go di land wey I don promise dem; land wey dey okay, good and fine well-well.
EZE 20:16 I tok like dat, bikos dem don break my law, rijet my kommand kon distroy di Sabat. Dem like to woship juju well-well.
EZE 20:17 But I still sorry for dem kon gri sey I nor go kill dem for di wildaness.
EZE 20:18 Instead, I warn di yong pipol wey dey with dem sey: ‘Make una nor follow di laws wey una papa dem make or follow wetin dem dey do or serve di juju wey dem dey serve.
EZE 20:19 Na mi bi una Oga and God, so make una obey my laws and kommand.
EZE 20:20 Make una keep di Sabat holy, so dat e go bi sign for di kovenant wey wi make and e go remind una sey na mi bi di Oga wey bi una God.’
EZE 20:21 “But dat generashon still rijet mi. Dem break my laws and dem nor gri keep my kommand wey dey give life to doz wey obey am. Dem distroy di Sabat finish. So, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish and I like to kill all of dem as dem dey di wildaness,
EZE 20:22 but I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.
EZE 20:23 So I kon swear again for di wildaness. I swear sey I go skata dem for evriwhere for di world.
EZE 20:24 I do like dis, bikos dem don rijet my kommand, break my law kon distroy di Sabat Day and dey serve di same juju wey dia grand-grand papa dem serve.
EZE 20:25 Den I give dem wiked laws and kommand wey nor dey give life.
EZE 20:26 I allow dem distroy dia life with dia own ofrin kon let dem sakrifice and kill dia first pikin. Dis na to ponish and show dem sey na mi bi God.
EZE 20:27 “Naw, man pikin, make yu go tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tell dem, Na so una papa dem take curse mi wen dem nor gri do di rite tin.
EZE 20:28 I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin.
EZE 20:29 I kon ask dem: ‘Wetin bi dis high place wey una dey go?’ (Dis na pagan shrine and na Bama wey mean high place dem dey koll am kon rish today.)
EZE 20:30 “Naw, make yu tell Israel pipol wetin I dey tok: Why una dey kommit di same sin wey una papa kommit kon dey run follow dia juju.
EZE 20:31 Even till today, dem still dey offa di same sakrifice and dey distroy demsef with di juju, bikos dem dey burn dia shidren for fire gi-am as sakrifice. Den Leta, una go still kom ask sey wetin I wont! But as long as I bi God wey get pawa and di God wey nor dey die, I nor go let una ask mi anytin.
EZE 20:32 “Una gri sey una won bi like di oda kountries; like pipol for oda kountry wey dey woship three and mountin. But una plan nor go work.
EZE 20:33 True-true, mi wey bi God wey get pawa, na mi bi di God wey nor dey die and I dey warn una sey if I vex, I go rule una with strong hand and with all my pawa.
EZE 20:34 Bikos I dey vex, I go use my strong hand take gada una togeda kom back from di kountries where I bin skata una go.
EZE 20:35 I go take una enter di wildaness wey dey di nashons and wi go stand face-to-face as I dey judge una.
EZE 20:36 As I take kondemn una grand-grand papa for Sinai wildaness, na so too, I go take kondemn una. Na God wey get pawa tok like dis.
EZE 20:37 Na mi, God dey kontrol una, so dat una go obey my kommand.
EZE 20:38 Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”
EZE 20:39 God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.
EZE 20:40 All of una for Israel go woship mi for di land wey dey on-top my holy mountin. I go dey good to una, so I espect una to give mi una sakrifice, betta ofrin and gifts wey dey holy.
EZE 20:41 Afta I don bring una kom back from di kountries where I skata una go before, I go asept di sakrifice wey una go give and evribody go si sey I dey holy.
EZE 20:42 Wen I don bring una kom back to Israel; di land wey I promise una grand-grand papa, den una go know sey na mi bi God.
EZE 20:43 Den una go remember all di yeye tins wey una do and di bad ones wey una do with una body. Una go vex for unasef, bikos of all di bad tins wey una bin do.
EZE 20:44 Dat time, bikos of who I bi, I nor go ponish una as e suppose bi, den una wey bi Israel pipol go know sey na mi bi God.”
EZE 20:45 God tell mi:
EZE 20:46 “Man pikin, look di sout-side for di kountry. Tok against di sout-side and en forest.
EZE 20:47 Tell di forest for sout sey make e hear wetin God dey tok: Look! I won start fire wey go burn all di tree wey dey inside yu; weda dem fresh or dry. Nor-tin go fit kwensh di fire. Di fire go from sout go nort and evribody go feel as di fire hot rish.
EZE 20:48 All of dem go si sey na mi wey bi God start di fire and nobody go fit off am.”
EZE 20:49 But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”
EZE 21:1 God tell mi:
EZE 21:2 “Man pikin, make yu prish against di temple for Jerusalem, where pipol dey go woship. Warn Israel pipol
EZE 21:3 sey mi wey bi God sey, ‘I bi dia enemy. I go kill all of dem with my swod, both bad and good pipol.
EZE 21:4 I go kill both good and wiked pipol! I go use my swod take kut and kill pipol from nort go rish sout.
EZE 21:5 Den evribody for di world go know sey, mi wey bi God don draw my swod kom out and nor-tin go let mi put am back.’
EZE 21:6 “So man pikin, make yu kry well-well, bikos dem don break yor heart. Cry with pain for where evribody go for si yu.
EZE 21:7 If dem ask yu sey wetin make yu dey kry, make yu tell dem sey, na bikos of di news wey dey kom. Wen di news kom, fear go katch dem well-well; dia hand nor go fit move, dia mind go fail dem and dia leg go dey shake. Di time don kom and na naw.”
EZE 21:8 God tell mi sey:
EZE 21:9 “Man pikin, tell di pipol wetin mi wey bi God dey tok:
EZE 21:10 “I dey sharp and klean swod to take kill pipol. I polish am and e dey shine like tonda lite. “Make my pipol dey happy? No! Dem nor fit, bikos dem don rijet all di warnin wey I give dem.
EZE 21:11 “I don polish my swod, bikos I won use am take kill. I go gi-am to di pesin wey go kill pipol.
EZE 21:12 So man pikin, make yu kry well-well, bikos I sharp dis swod to take kill my pipol and all di leaders for Israel. Dem go kill evribody, so make yu nak yor lap, bikos of dia pain.
EZE 21:13 “I dey test my pipol and if dem nor gri turn from sin kom meet mi, all dis tins go happen to dem.
EZE 21:14 “So make yu profesai and klap yor hands togeda. Di swod go attack and kill pipol again and again. E go kill my pipol well-well.
EZE 21:15 E dey make my pipol heart melt and doz wey go die go many well-well. My swod dey wait for all di gates, e dey shine well-well and e dey ready to kill.
EZE 21:16 Di swod go kut from rite and left! E go kut anytin wey e si.
EZE 21:17 Den, mi too go klap my hand and I nor go vex again.
EZE 21:18 God kon tell mi:
EZE 21:19 “Man pikin, choose two road where Babilon king go pass kom with en swod. Di two road must start from di same kountry. Do sign post make yu put am for where di roads for start kon enter di kountry.
EZE 21:20 One road go show di king where e go pass rish Ammon town for Rabbah and di oda one go show am Judah road; di strong town wey dey Jerusalem.
EZE 21:21 Babilon king go stand near di sign post for where di road for start. E go shake di arrow, ask en juju kweshon kon shake di animal liver wey dem sakrifice, so dat e go know where e dey go.
EZE 21:22 Di arrow wey mark ‘Jerusalem’ dey for en rite hand! E go-go gada rams kon ready for war. Some ram go dey di gate and dem go build betta wall kon dig many whole.
EZE 21:23 Jerusalem pipol nor go bilive wetin dey happen, bikos of di agriment wey dem make. But na to make dem remember dia sins and to warn dem sey dem go katch dem go prison.”
EZE 21:24 So, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok. “I don si una sins and evribody don know how una bad rish. Una sins dey show for evritin wey una dey do. Naw, God go kondemn and give una to una enemies.
EZE 21:25 Una wey bi wiked and bad leaders for Israel! Di day wey God go ponish una, dey kom.”
EZE 21:26 Mi, God wey get pawa, don tok. “So, make una remove una crown and di fine skaf wey una tie for head. Una life nor go bi as e bi before. I go honor doz wey dey honbol kon disgrace doz wey dem bi dey honor!
EZE 21:27 I go skata una finish! Yes, I go skata una. I go skata di town finish. But dis one nor go happen until di pesin wey I choose kom; di pesin wey I choose sey make e skata di town. Na en I go give dis tin to.”
EZE 21:28 “Man pikin, make yu profesai. Tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell Ammon pipol wey dey curse Israel. Tell dem sey: “ ‘One swod dey ready to skata; swod wey dem polish to kill and e dey shine like tonda lite.
EZE 21:29 Di vishons wey una si nor bi true and wetin una sey go happen, na lie. Una dey evil and wiked well-well and una day dey kom; di day wey God go ponish una, den di swod go kut una neck komot.
EZE 21:30 So, make una karry una swod go back to where una from bring am, bikos I go judge una for where dem for kreate una.
EZE 21:31 Una go feel my vexnashon like hot fire. And I go give una to wiked men wey sabi distroy tins.
EZE 21:32 Dem go distroy una with fire. Una blood go flow for una own kountry and nobody go remember una again.’ ”
EZE 22:1 God kon tell mi:
EZE 22:2 “Man pikin, yu don ready to judge di town wey dead body full? Tell dem all di bad-bad tins wey dem do.
EZE 22:3 Tell di town wetin mi God wey get pawa dey tok: Bikos una don kill many of una own pipol kon make unasef dirty as una dey serve juju; I go soon get una time.
EZE 22:4 Una really kill pipol and na di juju wey una dey serve, dey dirty una. So una day dey kom and una time go soon end! Na dis make mi allow nashons and kountries dey laf and fool una.
EZE 22:5 Di kountries wey dey far and di ones wey dey near, go laf una, bikos una nor konfuse well-well.
EZE 22:6 “All di leaders for Israel trust dia pawa and dem dey kill pipol.
EZE 22:7 Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.
EZE 22:8 Una nor dey respet di holy place or keep di Sabat holy.
EZE 22:9 Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.
EZE 22:10 Some dey sleep with dia papa wife, while odas dey force and sleep with woman wey dey si en period.
EZE 22:11 Some dey sleep with pipol wife or husband and odas dey sleep with dia pikin wife or dia half sistas.
EZE 22:12 Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.”
EZE 22:13 “Si, I dey klap my hand as una dey tif and kill.
EZE 22:14 Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok.
EZE 22:15 I go skata una go difren kountries and I go stop all dis bad tins wey una dey do.
EZE 22:16 So di oda nashons nor go respet una and una go know sey na mi bi God.”
EZE 22:17 God tell mi:
EZE 22:18 “Man pikin, Israel pipol nor dey yuzful to mi. Dem bi like iron, milk cup and sometin wey dem use remain.
EZE 22:19 Mi God wey get pawa dey sey, dem dey yuzles like di yeye tin wey dey kom out from iron afta dem don melt am. So, I go gada all of dem kom Jerusalem.
EZE 22:20 Just as dem dey put silva, koppa, iron, lead and milk cup for fire wey go melt dem, na so too I go vex gada una put for hot fire.
EZE 22:21 Yes! I go gada dem for Jerusalem kon put fire under where dem dey, den melt dem with my vexnashon.
EZE 22:22 Just as silva dey melt for fire, na so too dem go melt for Jerusalem, den dem go know and feel my vexnashon.”
EZE 22:23 God tell mi again sey:
EZE 22:24 “Man pikin, tell Israel pipol sey dia land dey dry and rain nor go fall, bikos I dey vex.
EZE 22:25 Dia leaders bi like lion wey dey happy for di animal wey e kill. Dem kill pipol, take all dia money kon kollect di propaty wey dem fit kollect and naw, many wimen nor get husband again, bikos of dis tin wey dem do so.
EZE 22:26 Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
EZE 22:27 Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.
EZE 22:28 Dia profets hide dis tins like wall wey dem kover with paint. Dem dey si wrong vishon and wetin dem sey go happen, na lie. Dem dey sey na God word dem dey tok, but mi God, nor tok to dem.
EZE 22:29 Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.
EZE 22:30 “I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody.
EZE 22:31 So, I go pour my vexnashon for dia head kon distroy dem with fire, bikos of di bad tins wey dem do.”
EZE 23:1 God tell mi:
EZE 23:2 “Man pikin, e get two sistas like dat.
EZE 23:3 Wen dem dey yong for Egypt, dem kon stay to do ashawo.
EZE 23:4 Di senior one name na Oholah (wey bi Samaria) while di yonga one na Oholibah (wey bi Jerusalem). I marry dem two and dem born shidren for mi.
EZE 23:5 Even doh e bi my wife, Oholah still dey do ashawo and e dey run follow Assyria sojas
EZE 23:6 wey wear purpol uniform; pipol wey dem dey respet, honor and wey fine well-well.
EZE 23:7 Na Oholah all di ofisas for Assyria dey sleep with, so e kon dirty ensef as e dey woship Assyria juju.
EZE 23:8 E still dey do ashawo and na from Egypt e for start to sleep with difren pipol. Na since e yong, men don dey sleep with am and dem dey trit am like ashawo.
EZE 23:9 So I kon gi-am to Assyria pipol wey e love well-well.
EZE 23:10 Dem naked am kon take en shidren komot en hand, den dem kill-am with dia swod. E kon turn who nor get shidren again and dem dey ponish am for evriwhere for di world.
EZE 23:11 Even doh en sista Oholibah si wetin happen, en own ashawo kon strong well-well pass Oholah own.
EZE 23:12 En too love Assyria ofisas; di sojas wey wear fine uniform and e even love di main ofisas and all di men wey fine.
EZE 23:13 I si sey e bad well-well. Dat is, di sekond sista kon dey do like di first one.
EZE 23:14 Dis one ashawo kon worse well-well. E even won sleep with di ofisas image wey dem karve for wall wey bi; Kaldea image wey dem karve; paint with red
EZE 23:15 kon tie belt for en waist with fine priest kap for en head.
EZE 23:16 As e just si dia image, e love dem kon send messenjas go meet and koll dem kom from Babilon.
EZE 23:17 Babilon pipol kom sleep with am. Dem use am anyhow kon make am dirty sotey e kon taya for dem.
EZE 23:18 E naked kom out kon let evribody know sey e bi ashawo. I vex for am, just as I vex for en sista.
EZE 23:19 En own ashawo dey worse evriday; e dey do tins wey e dey do since wen e start ashawo work for Egypt.
EZE 23:20 Just like donkey or horse, na so too e nor dey fit kontrol ensef wons e si man wey fine well-well.
EZE 23:21 Oholibah, yu won still do di ashawo wey yu do for Egypt wen yu bi small girl? Where men for dey play with yor breast and sleep with yu.
EZE 23:22 “Naw, Oholibah, dis na wetin God wey get pawa dey tell yu. Yu don taya for yor lovers, but I go make dem vex and gada round yu.
EZE 23:23 All di men for Babilon and Kaldea, I go bring dem kom from Pekod, Shoa, Koa and Assyria. I go gada doz fine men togeda.
EZE 23:24 Dem go attack yu from nort with many sojas and shariot. Dem wear shield and helmet for head and dem go gada round yu. I go give yu to dem and dem go judge yu with dia own law.
EZE 23:25 Bikos I dey vex for yu, I go let dem ponish yu as dem dey vex. Dem go kut yor nose and ear komot and dem go kill yor shidren. Yes! Dem go take yor shidren from yor hand kon burn dem alive.
EZE 23:26 Dem go tear yor klot kon take all yor gold.
EZE 23:27 I go stop yor yeye life and all di nonsense wey yu don do since wen yu bi small girl for Egypt. Yu nor go look anytin wey bi like juju again or tink about Egypt.”
EZE 23:28 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go give yu to pipol wey yu hate well-well.
EZE 23:29 Bikos dem hate yu, dem go take evritin wey yu don work for and yu nor go get anytin again; yu go dey naked like ashawo. Na yor yeye and ashawo life
EZE 23:30 make all dis tins dey happen to yu. Yu bi dia ashawo and yu don spoil yor body with dia juju.
EZE 23:31 Yu dey do as yor sista dey do and I go give yu dis ponishment cup wey I give yor sista make e drink from.”
EZE 23:32 God wey get pawa sey, “Yu go drink from yor sista cup; e dey big and deep. Evribody go laf yu well-well, bikos yor cup don full.
EZE 23:33 Di cup go make life taya yu and yu go bi like man wey don drink well-well. Dis cup get fear; wahala full am and na yor sista, Samaria, get am.
EZE 23:34 Yu go drink am dry, break am to pieces kon use am take tear yor breast.”
EZE 23:35 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Bikos yu forget and turn from mi, yu go sofa for yor ashawo life.”
EZE 23:36 God tell mi, “Man pikin, yu dey ready to judge Oholah and Oholibah? Judge dem for di yeye life wey dem live.
EZE 23:37 Dem sleep with pipol husband kon kill many pipol. Dem sleep with juju kon kill di boys wey dem born for mi. Dem sakrifice my shidren give juju.
EZE 23:38 Since dat one nor rish dem, dem dirty my temple kon skata di Sabat wey I make holy.
EZE 23:39 Di day wey dem sakrifice my shidren give juju, na dat day dem still dirty my temple!
EZE 23:40 Evritime, dem go send pipol go invite men kom from far. Di two sistas go baf kon take difren tins with gold take design dia face.
EZE 23:41 Dem go sidan for betta chair and for dia front, fine-fine tins like incense and olive oil wey I give dem, dey di tabol.
EZE 23:42 Pipol wey nor kare dey der dey shaut and na wildaness dem from bring dis pipol. Dem put shain for di wimen hand kon wear betta crown for dia head.
EZE 23:43 Den I tok about dis ashawo woman sey, ‘Dem go sleep with am naw.’
EZE 23:44 Dem dey sleep with am just as dem dey sleep with ashawo. Like dis, dem don sleep with Oholah and Oholibah wey bi ashawo.
EZE 23:45 Pipol wey dey do good go ponish dem, bikos dem kill and sleep with pipol and di pipol blood dey dia hand.”
EZE 23:46 So, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Make yu bring pipol wey go give dem wahala and tif from dem.
EZE 23:47 Make dem stone and attack dem with swods; kill dia shidren kon burn dia house rish groun.
EZE 23:48 I go stop all dis yeye life for dis land and e go bi warnin to wimen sey, make dem nor sleep with who nor bi dia husband, bikos dis na wetin dem dey do.
EZE 23:49 But for dis two sistas; I go ponish dem for dia ashawo life and di juju wey dem dey serve. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”
EZE 24:1 Nine years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di tent mont, God kon tell mi sey:
EZE 24:2 “Man pikin, make yu rite today date for groun, bikos Babilon king go seize Jerusalem.
EZE 24:3 Make yu go tell my sturbon pipol dis parabol wey mi, God get for dem: “Make una put di pot for fire kon pour wota full am.
EZE 24:4 Put di betta part for di meat inside: di shoulder, di legs and di difren parts.
EZE 24:5 Na di sheep wey fine pass, una go kook. Make una pak wood under di pot make di wota for kwik boil; den una go boil di bone and di meat well-well.”
EZE 24:6 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! E bi like dirty pot wey dem nor fit wosh klean. Dem dey remove di meat one-by-one and nor-tin remain inside.
EZE 24:7 Di pipol wey e kill, na dia blood dey di town. Di pipol blood nor tosh groun where san go for fit kover am. Instead, di blood stain di rock.
EZE 24:8 I don leave di blood for der; di place where dem nor go for fit hide am and e dey make mi vex more-more as e dey kry for revensh.”
EZE 24:9 Dis na wetin God wey get pawa dey tok, “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! Na mi go gada di wood by mysef.
EZE 24:10 So make una still bring wood kom! Blow di fire! Kook di meat! Boil am well-well. Yes! Make dem burn di bones finish.
EZE 24:11 Naw, put di empty pot on-top di shako, den leave am make e red well-well. Den di pot go dey klean again afta fire don burn di yeye tins wey dey inside komot.
EZE 24:12 But all dis yeye tins nor go vanish komot like dat.
EZE 24:13 Jerusalem pipol! Una yeye life don make una dirty, even doh I try make una dey klean, una still dirty. Una nor go dey klean again until my vexnashon don fall on-top una with full force.
EZE 24:14 “Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.”
EZE 24:15 God tell mi.
EZE 24:16 “Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.
EZE 24:17 Nor let pipol hear yu kry. Nor skrape yu head or waka with ordinary leg like sey yu dey mourn. Nor kover yor face or chop di kind food wey pipol wey dey mourn dey chop.”
EZE 24:18 So for early morning, I tok to di pipol. But my wife die for evening and di next day I kon do as God tell mi.
EZE 24:19 Pipol kon dey ask mi, “Wetin make yu dey bihave like dis?”
EZE 24:20 I ansa dem, “God sey make
EZE 24:21 I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’
EZE 24:22 Den una go do wetin I don do so. Una nor go kover una face or chop food wey pipol wey dey mourn dey chop.
EZE 24:23 Una nor go skrape una head or waka with ordinary leg like pipol wey dey mourn. Bikos of una sins, una go die anyhow kon dey komplain give each oda.
EZE 24:24 Ezekiel go bi ezample to una; una go do evritin wey I don do. God sey wen all dis tins happen, una go know sey na-im bi Oga God.”
EZE 24:25 God kon sey, “Man pikin, I go remove di strong temple wey bi dia joy and pride. Di temple wey dem dey like to look and visit. I go still take dia shidren komot dia hand.
EZE 24:26 For di day wey I go do wetin I tell yu so, pesin wey go eskape di wahala go kom tell yu di news.
EZE 24:27 Dat same day, yor mout go open and yu go fit tok again. Yu go tok to di pesin wey eskape kom and dis go bi sign to di pipol, den dem go know sey na mi bi God.”
EZE 25:1 Dis na wetin God tell mi:
EZE 25:2 “Man pikin, turn face Ammon kon tok against en pipol.
EZE 25:3 Tell dem sey make dem listin to wetin mi God wey get pawa dey tok: Una dey dance wen dem kill my pipol, distroy my temple and karry my pipol go Babilon as prisonas.
EZE 25:4 Bikos una dey happy, I go let di tribe from east win una for war. Dem go build dia kamp for una kountry kon stay for der. Di food and milk wey suppose bi una own, dem go chop and drink dem.
EZE 25:5 I go turn Rabbah to where dem go dey keep kamel put and evriwhere for Ammon go bi where dem dey keep sheep, den una go know sey, na mi bi God.
EZE 25:6 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Una klap una hand kon dey jump with happiness and dey curse Israel land.
EZE 25:7 So, bikos una dey curse am, I go give una to anoda kountry wey go tif and skata una. I go distroy una finish, den una go know sey na mi bi God.”
EZE 25:8 God wey get pawa sey: “Bikos Moab pipol sey Judah bi like di oda kountries,
EZE 25:9 I go let dem attack di towns wey dey near Moab, plus di towns wey fine pass for Moab wey bi: Bet-Jeshimot, Baal Baal-Meon and Kiriataim.
EZE 25:10 I go let di east tribe for wildaness win Moab and Ammon pipol for war, den Moab nor go bi kountry again.
EZE 25:11 I go ponish Moab pipol and dem go know sey na mi bi God.”
EZE 25:12 God wey get pawa sey, “Edom pipol revensh Judah well-well and dat revensh don make Edom pipol sin.
EZE 25:13 Naw, I don tok sey I go ponish Edom kon kill evribody with dia animals for der. I go distroy dia land from Teman town go rish Dedan town and di pipol go die for war.
EZE 25:14 My pipol Israel go revensh Edom and dem go let Edom pipol feel how my vexnashon strong rish. Den Edom pipol go know wetin e mean to take revensh.”
EZE 25:15 God wey get pawa sey, “Filistia pipol don revensh and kill Judah pipol well-well, bikos dem hate Judah.
EZE 25:16 But naw, I dey sey I go attack Filistia pipol kon kill all of dem. I go kill evribody wey dey Filistia and nobody go remain.
EZE 25:17 I go ponish and revensh dem. Dem go feel as I dey vex rish. Den dem go know sey na mi bi God.”
EZE 26:1 For di elevent years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di mont, God kon tell mi:
EZE 26:2 “Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’
EZE 26:3 Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: Tyre town, I bi una enemy and I go bring many kountries kon fight una and dem go kom like wave for sea.
EZE 26:4 Dem go distroy una town wall kon tear una towa. Den I go swip all di san-san komot der kon leave only di rock.
EZE 26:5 Pipol wey dey katch fish go dey sun dia net near di sea for der. Mi God don tok and dem go distroy Tyre
EZE 26:6 kon kill pipol wey dey inside di town with swod, den Tyre go know sey na mi bi God.”
EZE 26:7 God wey get pawa sey, “Make una listin, I go bring King Nebukadnezzar kom from Babilon, e strong pass evry oda king and e go attack Tyre. E go kom from nort with many sojas and shariot.
EZE 26:8 E go distroy una land, den e go attack una kon build wall round una town.
EZE 26:9 E go skata una wall kon break una towa with iron bar.
EZE 26:10 Di dust wey en horse dey kause go kover una. Di shariot nois go shake una wall as dem dey pass una town wey don skata.
EZE 26:11 Di pipol wey dey ride di horse go skata una street kon kill una pipol with swod and dem go break una strong pila rish groun.
EZE 26:12 Una enemies go kollect una money with evritin wey una get. Dem go break una wall kon skata all di house wey una build with betta money. Dem go take di fine stones, wood, rubi and evritin, den kon trow dem inside sea.
EZE 26:13 I go stop all una song and di music wey una harp dey play.
EZE 26:14 I go leave only one small rock, so dat doz wey dey katch fish go dey sun dia net for der. Dem nor go build di town again.
EZE 26:15 Oga God tok to Tyre town sey: “Wen dem dey win una, doz wey dey stay near di river go dey fear, bikos of pipol blood wey go dey flow pass.
EZE 26:16 All di kings for di kountries wey dey near river go kom down from dia throne. Dem go pul dia crown and fine-fine klot komot body kon sidan for groun dey fear bikos of how dem dey distroy una town.
EZE 26:17 Dem go sing sorrowful song for una sey: “ ‘Di town wey evribody know, don skata! Na en ship bin full di sea before, en pipol bin dey rule di sea and dey make evribody fear.
EZE 26:18 Naw, for di day wen e fall, di land for di sea centre go fall too and di pipol go fear, bikos of how e take skata.’ ”
EZE 26:19 God wey get pawa sey: “I go make di town empty and nobody go stay der again. I go kover di town with wota from river.
EZE 26:20 I go take am go where dead body dey. I go make una stay for dat undagroun wey empty and na dead body go bi una friend. Bikos of dis, una nor go ever kom out or stay with pipol wey dey alive again.
EZE 26:21 I go use una as ezample wey go make pipol fear and dat go bi una end. Even if pipol find una, dem nor go ever si una again.”
EZE 27:1 God sey,
EZE 27:2 “Man pikin, make yu sing sorrowful song for Tyre pipol;
EZE 27:3 di town wey dey near sea where dem for dey do business with pipol from difren place. Go tell dem wetin God wey get pawa dey tok: “Tyre pipol, una dey make mout sey una fine.
EZE 27:4 Wota surround una house and di pipol wey build una, build una like fine ship.
EZE 27:5 Dem use wood from Mount Hermon take build di ship kon use cedar from Lebanon take do en pole.
EZE 27:6 Dem use oak tree from Bashan take do di padol kon make di chair with wood from Cyprus, den kover am with ivory.
EZE 27:7 Na linen dem take make di sail; betta linen wey dem bring from Egypt and na from far yu go know, wons yu si am. Purpol klot wey fine pass for Cyprus, na-im dem take kover di window.
EZE 27:8 Di men wey dey padol una kanoe, na from Sidon and Arvad dem from kom. Na una men wey sabi work dey drive una ship.
EZE 27:9 Di karpenters na men wey dem train well-well for Gebal. All di drivers from di ship where dey pass, dey do business with una.
EZE 27:10 Na men from Persia, Lydia and Libya bi una sojas. Dem dey keep dia shield and kap for una barrak. Na dem dey win war for una pipol.
EZE 27:11 Sojas from Arvad join dey guide una wall and na men from Gamad dey guide una towa. Dem dey sun dia shield for una wall and na dem make una fine so.
EZE 27:12 “Una do business for Spain kon use silva, gold, iron, tin and lead take pay for evritin wey una buy.
EZE 27:13 Una do business for Greece, Tubal and Meshak kon sell una goods to get slaves and to kollect tins wey dem make with bronze.
EZE 27:14 Togarmah dey use dia horse and animals take buy tins from una hand.
EZE 27:15 Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get.
EZE 27:16 Aram pipol dey buy una goods. Dem give una emeralds, purpol klot, fine tins and linen, koral and rubis, so dat una go give dem some of una goods.
EZE 27:17 Judah and Israel pipol dey buy goods from una with wheat, honey, olive oil and spices.
EZE 27:18 Damaskus pipol dey buy una goods kon pay with wine from Helbon
EZE 27:19 and wool from Zahar. Vedan and Javan pipol dey give una iron and spices, so dat una go give dem some from wetin una get.
EZE 27:20 Dedan pipol dey give una klot wey dem dey put on-top horse, so dat una go give dem una goods.
EZE 27:21 Arab pipol and di rulers for Kedar dey give una lamb, sheep and goat just to get una goods.
EZE 27:22 Bikos of di tins wey una get, Sheba and Rama pipol dey give una jewels, gold and di spice wey fine pass.
EZE 27:23 Haran, Kanneh and Eden town; di sojas for Sheba, Asshur and Kilmad town; all of dem dey buy and sell with una.
EZE 27:24 Dem dey give una fine klot, purpol klot, fine gown, karpet wey dey shine and strong ropes.
EZE 27:25 Na big ship dem take dey karry una goods. “Una bi like ship for sea wey dem pak heavy load put.
EZE 27:26 But wen di men wey dey padol una ship, padol am rish di river centre, one wind from east go kom sink di ship.
EZE 27:27 Una with una many goods, drivers, ship karpenter and sojas, go die inside di sea wen di ship don sink.
EZE 27:28 Di pipol vois go loud well-well wen dem dey shaut, bikos na die dem dey.
EZE 27:29 Evribody wey dey drive di ship, go swim leave am. Di drivers and evribody go swim go stand for groun.
EZE 27:30 All of dem go kry well-well for una, dem go pak dust for head kon roll for ashes.
EZE 27:31 Dem go skrape dia hair for una kon wear sak klot. Dia heart go bitter as dem dey kry.
EZE 27:32 Dem go sing dis sorrowful song for una: ‘Any town dey wey bi like Tyre? Naw e don die for sea!
EZE 27:33 Wen en men enter sea go, dem dey give evry kountry wetin dem wont. Kings get money, bikos of di tins wey Tyre sell give dem.
EZE 27:34 Naw una don sink for sea. Una dey di sea bottom. Una goods and all una workers don vanish with una.’
EZE 27:35 Evribody wey dey stay near di sea, shok wen dem hear wetin happen to una. Even dia kings dey fear and e dey show for dia face.
EZE 27:36 Pipol wey dey sell and buy tins from oda nashons, dey hiss for una; una own don finish and una nor dey again.”
EZE 28:1 God tell mi.
EZE 28:2 “Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.
EZE 28:3 Si, yu tink sey yu wise pass Daniel and nobody fit hide anytin from yu?
EZE 28:4 Yor wisdom and wetin yu know, don make yu get money, gold and silva.
EZE 28:5 Yu do betta business kon get plenty gain and naw, yu dey make mout kon dey karry body up, bikos of yor money!
EZE 28:6 “Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: “ ‘Bikos yu tink sey yu dey wise as god,
EZE 28:7 I go bring enemies kom attack yu. Dem go distroy yu and all di fine-fine tins wey yu don use yor wisdom take get, go skata.
EZE 28:8 Dem go beri yu for pit and yu go die yeye deat for inside sea.
EZE 28:9 Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.
EZE 28:10 Yu go die like dog for strenjas hand.
EZE 28:11 God tell mi again sey,
EZE 28:12 “Man pikin, kry for wetin won happen to Tyre king. Tell am wetin mi God wey get pawa dey tok: “Yu bi betta ezample to pipol before. Yes! Yu bin fine well-well and get sense.
EZE 28:13 Yu dey stay for Eden, God gardin. Dem kover yu with fine stones like rubis, diamonds, topaz, beryl, karnelian, jasper, safayas, emeralds and turkwoise. Na gold dem take make evritin about yu and dem make all dis tins for yu for di day wey God kreate yu.
EZE 28:14 I put one angel wey pipol dey fear, make e guide yu. Yu dey stay for my mountin wey dey holy and dey waka for stones wey dey inside fire.
EZE 28:15 Wen God first kreate yu, yu bin dey bihave well, until yu kon start to do bad tins.
EZE 28:16 Yu just dey busy dey buy and sell and dis tins kon make yu dey misbihave and kommit sin. So I ask yu make yu komot from my mountin wey dey holy and di angel wey dey guide yu, porshu yu komot from di stone wey dey inside fire.
EZE 28:17 Bikos yu fine, yu kon dey karry body up and dey bihave like fool. Na dis make mi skata yu for groun as warnin to all di oda kings.
EZE 28:18 As yu dey buy and sell, na so too yu dey do bad tins and naw, where una for dey woship God, nor dey klean again. So, I vex set fire for di town kon burn am rish groun. Evribody don si sey yu don turn to ashes.
EZE 28:19 Naw, fear dey katch all di kountries wey bin dey kom meet yu, bikos yor end don rish.”
EZE 28:20 God tell mi:
EZE 28:21 “Man pikin, make yu tok against Sidon town.
EZE 28:22 Tell di pipol for der wetin mi God wey get pawa dey tell dem: “Sidon pipol, I bi una enemy and pipol go praiz mi, bikos of wetin I go do una. Dem go know sey na mi bi God wen I don show as I holy rish and afta I ponish evribody wey dey stay Sidon.
EZE 28:23 I go send diziz kom meet una and una blood go flow for una street. Pipol go attack una from evry korna and una go die finish. Den una go know sey na mi bi God.”
EZE 28:24 God sey, “Di kountries wey surround and dey fight Israel pipol before, nor go fight dem again. Dat time dem go know sey na mi bi God wey get pawa.”
EZE 28:25 God wey get pawa sey, “I go bring Israel pipol kom back from di kountries wey I skata dem go, den all di kountries go know sey I dey holy. Israel pipol go stay for dia own land. Di land wey I give my savant Jakob.
EZE 28:26 Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”
EZE 29:1 Ten years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di twelft day for di tent mont, God kon tell mi:
EZE 29:2 “Man pikin, make yu go tok against Egypt king. Tell am how I go take ponish both en and en pipol.
EZE 29:3 Tell am sey dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu wey bi juju for wota, I bi yor enemy naw. Yu sey na yu get and kreate Nile River abi?
EZE 29:4 I go hook yor jaw and fish for river go whole yu tit. Den, I go drag yu komot from Nile River with all di fish wey dey yor mout.
EZE 29:5 I go trow yu and all di fish inside desert. Yu go die for der and nobody go beri yu. Den I go give yor body to bird and animals make dem chop.
EZE 29:6 Dat time, all di pipol for Egypt go know sey na mi bi God. Aldo Israel pipol bilive sey Egypt pipol go kom help and fight for dem, but di trut bi sey, Egypt pipol na soft plant wey dey grow for wota.
EZE 29:7 Dem whole yu with dia hand, but yu break kon skata dia hand; wen dem won rest on-top yu, yu break dia back and dem nor fit stand again.
EZE 29:8 “Naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go allow pipol kom attack una with swod and dem go kill una with una animals.
EZE 29:9 Egypt go turn to where nobody dey stay. Den una go know sey na mi bi God. Bikos yu sey na yu get Nile River,
EZE 29:10 I don turn both yu and di river enemy. I go make evriwhere for Egypt empty and nobody go dey der again. From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout till e rish Sudan borda,
EZE 29:11 human being or animal nor go waka pass der again and for forty years, nor-tin go stay for der.
EZE 29:12 I go make sure sey na Egypt land empty pass for di world. For forty years, Egypt towns go skata. Yes! E go skata pass any oda place. I go make Egypt pipol bi strenjas and dem go dey look for where dem go stay. Dem go run go difren kountries kon stay with strenjas.”
EZE 29:13 God kon sey, “Afta forty years, I go bring Egypt pipol kom back from di kountries where I skata dem go
EZE 29:14 kon let dem stay for Egypt sout wey bi dia original house. For der, dem go bi pipol wey nor get pawa;
EZE 29:15 kountry wey weak pass and dem nor go ever fit rule any kountry again. I go make sure sey dem nor dey important and dem nor go fit make any kountry do wetin dem wont.
EZE 29:16 Israel pipol nor go ever go meet dem for help again. Bikos of wetin go happen to Egypt, Israel pipol go kon know sey, e nor even dey rite to go Egypt for help. Den Israel pipol go know sey na mi bi God wey get pawa.”
EZE 29:17 Twenty-seven years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di first mont, God kon tell mi:
EZE 29:18 “Man pikin, Nebukadnezzar wey bi Babilon king dey go attack Tyre. E sey make en sojas karry heavy load and na dis make di hair for dia head fall komot and dia shoulder peel. But even with all dis hard work, di king and en sojas nor get any reward.
EZE 29:19 So, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: I dey give Egypt land to King Nebukadnezzar. E go skata Egypt kon karry all di money wey Egypt take dey pay en sojas, go.
EZE 29:20 I dey give Egypt as payment for di work wey e do, bikos en sojas dey work for mi.”
EZE 29:21 “Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”
EZE 30:1 God kon tell mi again,
EZE 30:2 “Man pikin, go tell Egypt pipol wetin mi God wey get pawa dey tok. “Make yu shaut tok dis word sey: ‘Wahala day dey kom!’
EZE 30:3 Di day wen God go take akshon, don near. For dat day, darkness and trobol go full di kountry.
EZE 30:4 War go dey for Egypt and strong wahala go dey for Sudan. Dem go kill many pipol for Egypt. Di kountry go skata and e go dey empty.
EZE 30:5 “All di sojas wey dem hire kom from Sudan, Libya, Lydia, Arabia, Put and even from among my own pipol, go die for dat war.”
EZE 30:6 God sey, “From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout, evribody wey dey guide Egypt, go die finish for di war. Di sojas wey dey make Egypt proud, dem go distroy all of dem.”
EZE 30:7 “Na di land go empty pass for di world and en towns go skata finish.
EZE 30:8 Wen I don put fire for Egypt and all di sojas wey dey guide am don die finish, den dem go know sey na mi bi God.
EZE 30:9 “For dat same day afta I don distroy Egypt finish, I go send messenjas for ship go tell Ethiopia pipol sey wahala dey kom. Dem dey tink sey dem dey save, but naw, fear go katch dem.”
EZE 30:10 God wey get pawa sey, “I go use Babilon king, Nebukadnezzar take kollect evritin wey Egypt get.
EZE 30:11 En and en wiked sojas go kom skata di land. Dem go attack Egypt with swod and na dead body go full di land.
EZE 30:12 I go turn River Nile to dry land kon make wiked pipol rule Egypt. Yes! Strenjas go skata di whole town.
EZE 30:13 God wey get pawa sey, “I go distroy and skata di juju wey dey Memfis. Nobody go ever rule Egypt again and I go make all di pipol fear.
EZE 30:14 I go make di sout-side for Egypt empty kon put fire for Zoan town wey dey di nort. I go ponish Tebes wey bi di main town.
EZE 30:15 Pelusium, Egypt town wey get all dia betta tins, I go make am feel as I dey vex rish. I go distroy di money wey Tebes town get.
EZE 30:16 I go burn Egypt town and evribody for Pelusium go dey kry with pain. I go break Tebes wall rish groun kon kover di town with wota.
EZE 30:17 Di yong men wey dey On and Pi-Beset town go die for war and dem go katch and karry di rest pipol go prison.
EZE 30:18 Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.
EZE 30:19 Wen I don ponish Egypt like dis, dem go know sey na mi bi God.”
EZE 30:20 For di elevent year afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di sevent day for di first mont, God kon tell mi sey:
EZE 30:21 “Man pikin, I don break Egypt king hand. Nobody fit bandage am or do wetin go make am well or strong again and e nor go fit whole swod again.
EZE 30:22 Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘I bi Egypt pipol enemy. I go break di king two hand; both di one wey good and di one wey don break before, den en swod go fall for groun.
EZE 30:23 I go skata Egypt pipol go difren place for di world.
EZE 30:24 Den I go make Babilon king strong kon put my swod for en strong hand. But I go break Egypt king hand and e go kry kon die for en enemies front.’
EZE 30:25 Yes! Na mi make am weak, so dat Babilon king go strong. Wen I give Babilon king my swod and e point am face Egypt, evribody go know sey na mi bi God.
EZE 30:26 I go skata Egypt pipol for evriwhere for di world. Den, dem go know sey na mi bi Oga God.”
EZE 31:1 For di elevent year afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di third mont, God kon tell mi:
EZE 31:2 “Man pikin, go tell Egypt king and all en pipol sey: “ ‘Wetin I feel sey una resemble bikos una get pawa?
EZE 31:3 Una bi like cedar tree for Lebanon wey get betta shape, fine-fine branches and wey tall rish di kloud.
EZE 31:4 Di tree dey get enough wota wey go help am grow well-well and wota dey flow from der go wota di oda trees for di forest.
EZE 31:5 Bikos dem wota am well-well, e kon grow and tall pass any oda tree; en branches long and tick well-well.
EZE 31:6 Difren birds dey build dia house for der and wild animals dey born for under di tree. All di kountries for di world dey rest under en shadow.
EZE 31:7 Make una si as di tree fine rish! E tall and en branches dey strong more-more as dem dey grow. En rut long rish di river bottom.
EZE 31:8 No cedar or tree for God gardin fine rish am. No tree don ever get en kind branches before.
EZE 31:9 Na mi make am fine like dat with big-big branches. Evry tree for Eden wey bi God gardin, dey jealous am.
EZE 31:10 “ ‘Naw, mi wey bi God wey get pawa, go tell yu wetin go happen to dis tree wey grow rish di kloud. As e dey grow dey tall, na so en pride dey grow too;
EZE 31:11 so I don rijet am and I go let strenjas rule am. Dem go give di tree wetin e deserve, bikos of en wikedness.
EZE 31:12 Sojas from one wiked kountry go kut am down kon leave am der make e die. En branches wey don break go fall on-top all di mountins and valley for di kountry. All di kountries wey bin dey stay under am, go run leave am.
EZE 31:13 Birds go land on-top di tree for groun and wild animals go waka pass en branches.
EZE 31:14 So from naw go, no matter how dem wota any tree rish, e nor go grow kon tall rish di kloud again. All of dem must die like man pikin, dem must die go where dead body dey.’ ”
EZE 31:15 “Dis na wetin God wey get pawa dey tok: ‘Di day wey di tree go die, I go kover am with wota and pipol go kry for am. I go stop en wota and river nor go flow again. Bikos di tree don die, I go let darkness kover Mount Lebanon and all di trees for di forest go dry finish.
EZE 31:16 Wen I send am go where dead body dey, nois wey e go make wen e fall, go shake di whole world. All di trees for Eden and di betta wota for Lebanon wey dey under di world, go happy wen e fall.
EZE 31:17 En friends go follow am die kon go join doz ones wey don already fall. And all of dem wey dey stay under en shadow, go skata go evriwhere.
EZE 31:18 Na Egypt king and en pipol bi di tree. E get any tree for Eden wey tall and fine like una? But naw, like di trees for Eden, una go die kon join wiked pipol and doz wey dem kill for war.
EZE 32:1 Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di twelft mont, God kon tell mi.
EZE 32:2 “Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.
EZE 32:3 Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.
EZE 32:4 I go trow yu for groun make all di birds and animals for di world chop yu finish.
EZE 32:5 I go spread yor rotin flesh for di mountins and valleys.
EZE 32:6 I go pour yor blood from groun go rish on-top di mountin and blood go full di valley.
EZE 32:7 Wen I don distroy yu, I go kover di sky kon komot di stars. Di sun go hide for di kloud back and di moon nor go shine again.
EZE 32:8 I go off all di lite for heaven kon kover di world with darkness.’ ”
EZE 32:9 “Di kountries wey yu neva hear of before, wen I tell dem how I take distroy yu, fear go katch dem.
EZE 32:10 Wetin I do yu go make many kountries dey fear and dia kings go dey shake with fear bikos of yor kondishon. For di day wey yu go fall, all of dem go dey fear for dia own life.”
EZE 32:11 God wey get pawa kon tell Egypt king sey, “Babilon king go kom fight yu.
EZE 32:12 “I go let sojas from kountries wey get pawa, kill yor men for war. Dem go distroy all yor pipol and evritin wey dey make yu karry body up.
EZE 32:13 I go distroy all yor animals near where wota dey and nobody or animals go disturb di wota again.
EZE 32:14 Den I go make di wota kwayet again kon make di sea flow like oil.”
EZE 32:15 “Wen I don make Egypt land empty and distroy evritin wey dey der, den una go know sey na mi bi God.
EZE 32:16 Dis warnin wey I dey give dem naw so, go turn to sorrowful song Leta. Di wimen go sing di song as dem dey mourn for Egypt and en pipol.”
EZE 32:17 For di Fifteent day for di first mont for di twelft year, God kon tell mi:
EZE 32:18 “Man pikin, kry for Egypt pipol. Send dem with di oda kountries wey get pawa go where dead body dey.
EZE 32:19 Tell dem sey, ‘Who una tink sey una fine pass? Una go-go where dead body dey kon follow wiked pipol stay der.’
EZE 32:20 Egypt pipol go fall with doz wey die for war. Yes! One swod dey ready to kill all of dem.
EZE 32:21 Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’
EZE 32:22 “Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war
EZE 32:23 and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.
EZE 32:24 “Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
EZE 32:25 Among doz wey don die, dem make somewhere for Elam and en pipol. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
EZE 32:26 “Meshak and Tubal dey der too and en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
EZE 32:27 Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.
EZE 32:28 “But naw, dem go win una and una go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
EZE 32:29 “Edom dey der with en kings and rulers. Dem bi sojas wey get pawa, but naw, dem don die kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
EZE 32:30 “All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
EZE 32:31 God wey get pawa sey, “Wen Egypt king and en sojas go si doz wey dem kill for war, belle go sweet dem small.
EZE 32:32 Aldo, na mi worry Egypt king wen e dey alive, so en and en sojas go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
EZE 33:1 God kon tell mi.
EZE 33:2 “Man pikin, go tell yor pipol wetin go happen. Den tell dem sey: ‘If I bring war kom di land and di pipol choose one man wey go dey wosh for di gate.
EZE 33:3 Wen e si dia enemies dey kom, e go ring di bell to warn evribody.
EZE 33:4 If anybody hear and nor gri listin to am and di enemies kon kill-am, na-im kause en deat by ensef.
EZE 33:5 En deat na-im own fault, bikos e nor gri listin to di warnin. If to sey e listin, e for run go hide.
EZE 33:6 But if di wosh-man si di enemies dey kom and e nor ring di bell, di enemies go kill di pipol bikos of dia sin, but I go whole di wosh-man for dia deat bikos e nor warn dem.’
EZE 33:7 “Naw, man pikin, I dey put yu as wosh-man for Israel. Yu must go tell dem di warnin wey I dey tell yu so.
EZE 33:8 If I sey wiked pesin go die and yu nor warn am to shange, so dat e go save en life, den e kon die as sina, I go whole yu for en deat.
EZE 33:9 But if yu warn am and e nor gri stop to do bad tins before e die, den yor hand nor dey for en deat.”
EZE 33:10 God kon tell mi. “Man pikin, go tell Israel pipol wetin dem dey tok: ‘Na awa sins and di wrong tins wey wi dey do, dey ponish us so. Wi don die finish so how wi won take survive naw?’
EZE 33:11 Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’
EZE 33:12 “Naw, man pikin, go tell Israel pipol sey wen good pesin sin, di good wey e do, nor go save am. Like dis too, if wiked man stop to do bad, I nor go ponish am, but if good man start to sin, I nor go sorry for am at-all.
EZE 33:13 I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.
EZE 33:14 Like dis too, I fit warn wiked pesin sey e go die, but if e stop di bad tins wey e dey do kon dey do wetin good and rite;
EZE 33:15 for ezample, if e riton di propaty wey e take from pesin, bikos e borrow am money or give pipol back wetin e tif from dem kon stop to sin, den bigin follow di law wey dey give life, e nor go die and e go get long life.
EZE 33:16 I go forgive en sins and e go get di life wey nor dey end, bikos e don do wetin dey rite and good.
EZE 33:17 “With all dis, yor pipol dey sey wetin I dey do nor dey rite. No! Na dia ways nor dey rite.
EZE 33:18 Wen pesin wey good for God eye stop to do good kon dey do bad tins, e go die bikos of di bad tins wey e dey do.
EZE 33:19 But wen wiked pesin stop to sin kon dey do wetin dey good for God eye, e don save en life bi dat.
EZE 33:20 But Israel pipol, una sey wetin I do, nor good. So I go judge una with wetin una dey do.”
EZE 33:21 Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.”
EZE 33:22 But for di evening before e kom, I feel as God present strong rish. So wen di man kom di next morning, God kon give mi di pawa to tok.
EZE 33:23 God kon tell mi.
EZE 33:24 “Man pikin, di pipol wey dey stay di empty town for Israel dey sey: ‘Abraham na just one man and dem gi-am di whole land. So naw wey wi many well-well, na wi get di land too.’
EZE 33:25 Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land?
EZE 33:26 Una bilive sey una get pawa; dey bihave anyhow and evribody dey sleep with who nor bi dia husband or wife. So wetin make una dey tink sey na una get di land?’
EZE 33:27 “Go tell dem sey mi, God dey warn dem sey, ‘As long as I bi di God wey dey alive, di pipol wey dey stay for di main field, go die. Wiked animals go chop doz wey dey stay for di kountry and na diziz go kill doz wey hide for mountin and whole.
EZE 33:28 I go make di kountry empty finish kon end di pawa wey make dem dey proud before. Israel mountins go empty and nobody go fit travel pass der again.
EZE 33:29 Wen I ponish di pipol for dia sin kon make di kountry empty, den dem go know sey na mi bi God.’ ”
EZE 33:30 God sey, “Man pikin, yor pipol dey tok about yu wen ever dem meet for di town wall or for dia house door-mot. Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi go hear wetin God tok.’
EZE 33:31 So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.
EZE 33:32 To dem, yu bi like pesin wey dey joke, sing love song or play harp. Dem dey listin to evry word wey yu tok, but dem nor dey obey any one.
EZE 33:33 But wen wetin yu tok don happen and e go happen, den dem go know sey na profet dey with dem since.”
EZE 34:1 God kon tell mi.
EZE 34:2 “Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.
EZE 34:3 Una drink milk kon wear klot wey dem make with wool, den una kill and chop di sheep wey fine pass. But una nor gri kare for una pipol.
EZE 34:4 Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.
EZE 34:5 Bikos di sheep nor get shepad, dem kon skata for evriwhere and wiked animal kon dey kill and chop dem.
EZE 34:6 So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.
EZE 34:7 “ ‘Naw, una wey bi shepad, make una listin to wetin mi, God dey tell una.
EZE 34:8 As long as I bi di God wey nor dey die, e go betta for una if una listin to mi. Wiked animals attack my sheep kon kill and chop dem, bikos dem nor get who dey guide dem. My shepads nor even try to look for di sheep, instead na diasef dem kare about.
EZE 34:9 So make una listin to mi.
EZE 34:10 Mi wey bi God wey get pawa dey sey I bi una enemy. I go take my sheep from una hand and una nor go bi dia shepad again; I nor go let una kare for unasef again. I go save my sheep from una and una nor go chop dem again.
EZE 34:11 “ ‘Mi wey bi God wey get pawa dey tell unasef sey, mi mysef go look and kare for my sheep,
EZE 34:12 just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go.
EZE 34:13 I go remove dem from strenja land; gada dem togeda kon bring dem back to dia own kountry. I go lead dem go back to di mountin and Israel river wey dey flow kon give dem betta food chop.
EZE 34:14 I go let dem stay for peace for di mountins, valleys and all di fine field.
EZE 34:15 Na mi mysef go bi dia shepad and I go give dem place to rest.
EZE 34:16 “Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
EZE 34:17 “Naw my sheep, mi wey bi God wey get pawa dey tell una sey I go judge each of una kon separate di good ones from di bad ones; dat is, di sheep from di goat.
EZE 34:18 Some of una nor dey beleful; even doh una dey chop betta grass, una still dey mash wetin una chop remain! Una dey drink klean wota kon dirty di ones wey una drink remain!
EZE 34:19 Na my oda sheep go kom chop di grass wey una don mash and drink di wota wey una don dirty?
EZE 34:20 “So naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go judge both di strong and di weak sheep.
EZE 34:21 Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der.
EZE 34:22 But I go save my sheep and I nor go let una trit dem anyhow again. I go judge my sheep dem kon separate di good ones from di bad ones.
EZE 34:23 “I go give dem king wey bi like my savant David, wey go bi dia shepad and e go kare for dem.
EZE 34:24 Mi God go bi dia God and one king like my savant David go rule dem.
EZE 34:25 “I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.
EZE 34:26 I go bless dem kon let dem stay near my holy hill and for der, I go bless dem with betta rain anytime wey dem wont am.
EZE 34:27 Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.
EZE 34:28 Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.
EZE 34:29 I go make dia groun dey bear betta plant and honga nor go dey again. Di oda kountries nor go laf dem again.
EZE 34:30 Evribody go know sey na mi dey protet Israel and dem bi my pipol.
EZE 34:31 God wey get pawa sey, “Una bi my sheep; di animals wey I dey feed! Na una bi my pipol and na mi bi una God.”
EZE 35:1 God tell mi:
EZE 35:2 “Man pikin, make yu tok against Edom.
EZE 35:3 Tell Edom pipol, ‘God wey get pawa sey: “ ‘I bi una enemy! I go make una land empty.
EZE 35:4 I go skata una town kon distroy una land, den una go know sey na mi bi God.
EZE 35:5 “ ‘Na una bi di enemy wey dey worry and kill Israel pipol wen dem dey wahala and dat time na dia final ponishment for dia sin, dem dey face.
EZE 35:6 So, as long as mi God wey get pawa bi di God wey nor dey die, una must die and una nor go fit eskape am. Just as una kill pipol, na so too dem go kill una.
EZE 35:7 Edom pipol wey dey stay di hill, I go make una land empty and nobody go travel pass der again.
EZE 35:8 Na dead body I go take kover di mountins and doz wey die for war, na dem I go use take kover di hills and valley.
EZE 35:9 I go make una dey empty forever and nobody go stay una town again. Den una go know sey na mi bi God.
EZE 35:10 “ ‘Una sey, “Judah and Israel land na awa own. Wi go take evritin wey dey here. Wi nor kare weda Oga God dey stay der!”
EZE 35:11 So, as long as mi God wey get pawa bi di God wey nor dey die, I go ponish una akordin to how una vex rish, dey jealous and as una hate my pipol rish. My pipol go know sey I dey ponish una, bikos of wetin una do dem.
EZE 35:12 Den una go know sey, mi God hear wen una sey, “Israel mountin don empty, so na wi get am naw.”
EZE 35:13 I hear as una dey make mout and curse mi.
EZE 35:14 God wey get pawa sey, I go make una land empty and di whole world go dey happy as una dey fall;
EZE 35:15 just as una dey happy wen Israel skata; Israel land wey bi my own. Mount Seir pipol and all of una for Edom go die finish. Den evribody go know sey na mi bi God.’ ”
EZE 36:1 God sey, “Man pikin, make yu tell Israel mountin sey make dem listin to di message wey mi
EZE 36:2 God wey get pawa dey tell dem. Israel enemies tok against dem sey, ‘Naw, dis old hill don turn awa own naw!’
EZE 36:3 So go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok. Wen di kountries wey dey near Israel katch and seize Israel mountin, evribody bigin laf dem.
EZE 36:4 So di mountins, hills, rivers and valleys, make una listin to wetin mi God wey get pawa dey tell una. Aldo sey una towns skata naw and oda nashons dey curse and laf una,
EZE 36:5 I dey vex naw, so mi wey bi God go ponish dem especially Edom pipol, bikos na dem laf una pass kon kollect una land.
EZE 36:6 “So, make yu profesai about Israel land kon tell di mountins, hills, rivers and valleys sey, ‘God wey get pawa sey: Di way di oda kountries trit una, dey make mi vex.’
EZE 36:7 So God dey promise sey, doz kountries wey bin laf una, I go must sofa dem too.
EZE 36:8 “But trees go grow again on-top Israel mountins and dem go bear fruits for my pipol Israel and una go-go back to una own land.
EZE 36:9 I dey una side; I go make sure sey una land dey good and una go fit plant put again.
EZE 36:10 I go make una many. Una go stay for di town and evritin wey don skata before, una go ribuild dem back.
EZE 36:11 I go make una pipol and animals dey plenty evriday. Una go many pass as una bi before and una shidren go plenty. I go let una stay here as una dey before kon make una betta pass before. Den una go know sey na mi bi God.
EZE 36:12 I go bring my pipol, Israel kom back to dis land. Di land go bi dia own and dia shidren nor go ever hongry again.
EZE 36:13 “Mi, God wey get pawa sey, ‘Di land nor dey produce betta food so pipol and dia shidren dey die anyhow.’
EZE 36:14 But from naw go, all doz tin nor go ever happen again.
EZE 36:15 “Di land know go listin to doz kountries wey dey laf or curse en pipol. Di land nor go make una shidren hongry or die again.
EZE 36:16 God kon tell mi:
EZE 36:17 “Man pikin, wen Israel pipol bin dey dis land, dem spoil am with di way dem dey do and bihave. I si sey dia karata nor dey good and klean and bi like woman wey dey si en period.
EZE 36:18 Bikos of di pipol wey dem don kill for di land and juju wey dem pak full am, I kon let dem feel as my vexnashon strong rish.
EZE 36:19 I kondemn and skata dem go evriwhere, bikos of how dem dey live dia life.
EZE 36:20 Dem dey disgrace my holy name for anywhere wey dem go, bikos pipol dey sey, ‘Dis pipol don komot from di land wey dia own God, give dem.’
EZE 36:21 Na dis make mi dey koncern about my holy name wey Israel pipol dey make oda pipol spoil.
EZE 36:22 “Naw, make yu go tell Israel pipol dis message wey mi God wey get pawa get for dem: Wetin I won do nor bi bikos of una, but na bikos of my holy name; di name wey una don disgrace for evriwhere.
EZE 36:23 Wen I show di kountries how my name dey holy and great rish; di name wey una dey disgrace, dem go know sey na mi bi God. Mi, God wey get pawa, don tok.” “I go use una take show di kountries sey I dey holy.
EZE 36:24 From evry tribe, kountries or towns wey una dey, I go bring una kom back to una house.
EZE 36:25 I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.
EZE 36:26 I go give una new heart; di one wey go make una obey my kommand.
EZE 36:27 I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una.
EZE 36:28 Den una go stay for di land wey I give una grand-grand papa dem. Una go bi my pipol and I go bi una God.
EZE 36:29 I go save una from evritin wey make una dey spoil before. I go kommand food make e plenty, so dat una nor go hongry again.
EZE 36:30 I go make di fruit and food for una tree and fields many pass before, so dat honga nor go make una go beg oda nashons.
EZE 36:31 Wen una remember di wiked and wrong tins wey una do before, una go hate unasef, bikos of una sins.
EZE 36:32 Israel pipol, I wont make una know sey I nor dey do all dis tins bikos of una. So make una shame and hide una face bikos of all di bad tins wey una don do.
EZE 36:33 God wey get pawa sey, “Wen I don klean una from all una sins, I go let una plenty kon ribuild una towns wey don skata.
EZE 36:34 Doz wey pass una field before, si as dirty and grass grow full am, but naw, I go let una plant seed for der again.
EZE 36:35 Dis land wey bi like wildaness before, evribody go si and tok how e don turn and fine like Eden Gardin and how di town wey skata rish groun before, don fine and get pipol again.
EZE 36:36 Den di nashons wey dey near der, wey survive, go know sey mi wey bi God don ribuild dis town wey skata before kon plant put for di field wey bin dey empty. Mi wey bi God don promise sey, I go do wetin I sey I go do.”
EZE 36:37 God wey get pawa sey, “I go allow Israel pipol ask mi for help and dem go plenty like sheep again.
EZE 36:38 Just as sheep wey dem won offa as sakrifice dey full Jerusalem before di feast, na so too pipol go full di town wey bin dey empty. Den evribody go know sey na mi bi God.”
EZE 37:1 Den God pawa enter my body and en spirit kon karry mi go one valley where dry bones full.
EZE 37:2 E take mi waka round di place and I kon si sey di bones many and dem dry well-well.
EZE 37:3 E kon tell mi, “Man pikin, yu bilive sey dis bones fit turn to human being again?” I kon ansa, “God wey get pawa, na only Yu fit ansa dat kind kweshon!”
EZE 37:4 E kon sey, “Tok to di bones. Tell di bones sey make dem listin to wetin God dey tok.
EZE 37:5 Make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: I go give una life again.
EZE 37:6 I go give una flesh kon kover una body with skin. I go bring una kom back to life. Den una go know sey na mi bi God.”
EZE 37:7 So I tok to di bones just as God tell mi. As I dey tok, I hear one strong nois and di bones kon dey join togeda.
EZE 37:8 As I dey look, flesh kon kover di bones, den dem kon get skin. But dia body nor get life.
EZE 37:9 God kon tell mi, “Man pikin, tok to di breeze. Tell di breeze sey God wey get pawa dey kommand am to kom from difren place kon give life to dis body dem wey dey groun, so dat dem go get life.”
EZE 37:10 So I kon tok as God don tell mi. Life kon enter di body dem and dem kon stand up. Dem many well-well like sojas.
EZE 37:11 God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.
EZE 37:12 So, go tell Israel pipol sey mi wey bi dia Oga God go open dia graves kon take dia dead body kom out; give dem life, den bring dem kom back to Israel land.
EZE 37:13 Wen I open di grave where dem beri my pipol put kon bring dem out, na den dem go know sey na mi bi God.
EZE 37:14 I go give dem my own Spirit kon make dem stay for dia own land. Den, dem go know sey na mi bi God. I don promise sey I go do wetin I tok and I go do am.
EZE 37:15 God kon tell mi again:
EZE 37:16 “Man pikin, take one stik make yu rite dis word put, ‘Judah kingdom.’ Den take anoda stik kon rite dis word put too, ‘Israel kingdom.’
EZE 37:17 Den hold di two for hand, so dat dem go look like one stik.
EZE 37:18 Wen yor pipol ask yu sey make yu tell dem wetin dis tin mean,
EZE 37:19 tell dem sey, ‘God wey get pawa go take di stik wey dem rite Israel put kon join am with di one wey dem rite Judah put. E go use di two make one stik kon hold am for en hand.’
EZE 37:20 So, make yu hold di two stik for yor hand, so dat di pipol go si dem.
EZE 37:21 Den make yu tell dem sey, ‘God wey get pawa go-go bring all en pipol for evriwhere wey dem skata go. E go bring dem kom back to dia own land.
EZE 37:22 For di land wey dey Israel mountin, God go turn all of dem to one nashon. Dem go get one king wey go rule dem and dem nor go skata again.
EZE 37:23 Dem nor go spoil dia body with juju or anytin wey go make dem dirty or sin again. God go free dem from evritin wey dey make dem sin. E go klean dem; dem go bi en pipol and E go bi dia God.’
EZE 37:24 “Na from my savant David house, dia king go from kom. All of dem go dey happy under one king and dem go obey and respet all my laws.
EZE 37:25 Dem go stay for di land wey I give Jakob wey bi my savant; di land where dia grand-grand papa dey before. Dem with dia shidren and grand-shidren go stay der forever. Na from my savant David house, dia king go always kom from.
EZE 37:26 I go make kovenant with dem wey go make dem dey save forever. I go make dem prosper and dem go many well-well. I go make sure sey my temple dey for dia land forever.
EZE 37:27 I go stay der with dem; I go bi dia God and dem go bi my pipol.
EZE 37:28 Wen I don build my temple for dia land forever, den di oda nashons go know sey, mi God don choose Israel as my own pipol.”
EZE 38:1 God sey,
EZE 38:2 “Man pikin tok against Gog, dat wiked prince wey dey rule Meshak and Tubal wey dey Magog land.
EZE 38:3 Tell am sey mi God wey get pawa na en enemy.
EZE 38:4 I go turn am round; hook en jaw kon drag en and en plenty sojas.
EZE 38:5 I go drag Persia, Ethiopia and Libya sojas follow dem; plus all di swod wey dem karry.
EZE 38:6 “All di men wey sabi fight for Gomer and Togarmah land for nort and men from difren kountries,
EZE 38:7 tell dem make dem dey ready with all dia many sojas and na yu go kommand dem,
EZE 38:8 bikos afta sometaim, I go kommand una to attack Israel land; kountry wey bin skata bikos of war. Nobody stay di land since, but en pipol don kom back from oda kountries where dem bi prisonas before. Naw, Israel pipol dey stay for peace for dia land.
EZE 38:9 Yu, yor sojas and all di many kountries wey dey with yu go attack Israel like betta strong rain and una go bi like kloud wey kover di eart.”
EZE 38:10 Dis na wetin God wey get pawa dey tell Gog: “Wen dat time don rish, yu go start to tink of di wiked tins wey yu go do.
EZE 38:11 Yu go skata Israel kountry wey nor get who dey protet dem; place where di pipol nor get pawa and dey stay for peace.
EZE 38:12 Doz wey dey stay dis town wey nor skata before, yu go skata and karry dia propaty go. Dis pipol na prisonas for oda kountries before, but naw, dem don get plenty animals and propaty, so dem feel sey na dem get di whole world.
EZE 38:13 Sheba and Dedan pipol with doz for Tarshish go kom meet yu sey dem wont make yu give dem some from di silva and gold, plus di animals and propaty wey yor sojas kollect from Israel land.”
EZE 38:14 So, God wey get pawa kon send mi go tell Gog wetin E tok: “Naw, as my pipol Israel dey stay for peace, yu go
EZE 38:15 from yor land go take many sojas from difren kountries too, both from nort and all of dem go karry shariot.
EZE 38:16 Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.
EZE 38:17 “Na yu I dey tok about before wen I tell my savant wey bi Israel profet sey, ‘For dat day, I go ask somebody make e attack Israel.
EZE 38:18 God wey get pawa sey, “Wen Gog go attack Israel, I go vex well-well.
EZE 38:19 I go vex kon sey, ‘For dat day, many eartkweke go happen for Israel.
EZE 38:20 All di fish, bird, animal; weda dem big or small and evry human being wey dey stay dis eart, go fear mi well-well. Mountins go fall; high hill go skata and evry wall go fall skata too.
EZE 38:21 I go make Gog fear mi kon ponish am with diziz. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.’ ” “Gog men go fight and kill each oda.
EZE 38:22 I go ponish am with diziz and en pipol go dey kill each oda anyhow. Heavy rain, big-big stones, fire and sulfur go fall on-top en and en sojas; plus all di oda kountries wey dey en side.
EZE 38:23 Na like dis I go take show all di kountries as I dey great and holy rish. Den, dem go know sey na mi bi God.”
EZE 39:1 God wey get pawa sey, “Man pikin, go tok against Gog wey dey rule Meshak and Tubal sey, ‘I bi en enemy.
EZE 39:2 I go take am go anoda place for nort until e rish Israel mountin.
EZE 39:3 Den I go nak en bow komot from en left hand and di arrow wey dey en rite hand.
EZE 39:4 Gog, en sojas and all di pipol wey dey stay with am go die finish for Israel mountin and I go let bird and wiked animals chop dia body.
EZE 39:5 Dem go die for war.
EZE 39:6 “I go set fire put for Magog land and land near di river where pipol dey stay for peace. Den evribody go know sey na mi bi God.
EZE 39:7 I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”
EZE 39:8 God wey get pawa sey, “Wetin I dey tok about, go must kom.
EZE 39:9 Di pipol wey dey stay Israel town go-go kollect doz tins wey dem take dey kill pipol kon use am do firewood and dem bi: di swod, di shield, di bow, di arrow, di spear and dem go use dem as firewood for seven years.
EZE 39:10 Dem nor nid to go gada wood for di field or go kut tree for forest, bikos di swods go rish dem take make fire. Doz wey tif and karry my pipol propaty before, my pipol go kollect di load back from dia hand.”
EZE 39:11 God sey, “Wen all dis tins dey happen, I go give Gog one grave for Travelas Valley wey dey di Dead Sea for Israel east. Dem go beri Gog and all en sojas for der and dem go koll am ‘Hamon-Gog Valley.’
EZE 39:12 Na seven mont e go take Israel pipol to beri all di dead body kon make di land klean again.
EZE 39:13 Evribody for di land go join beri dem, den pipol go respet dem afta dem don win di fight.
EZE 39:14 “Afta di sevent monts, dem go choose men wey go travel round di land, so dat dem go fine and beri di dead body wey remain, so dat di land go dey klean.
EZE 39:15 As dem dey travel round di kountry, wons dem si human being bone, dem go mark dat place, so dat doz wey dey beri go si di bones kon beri dem for Hamon-Gog Valley.
EZE 39:16 (E get one town for der and dem go gi-am Gog sojas name wey bi Hamonah.) So di land go dey klean again.”
EZE 39:17 God wey get pawa kon tell mi, “Man pikin, go koll all di birds and animals make dem kom from evriwhere kon chop di sakrifice food wey I dey make for dem. Na party dem won do on-top Israel mountin so and dem go chop and drink blood.
EZE 39:18 Dem go chop sojas body kon drink ruler and leaders blood; all dis pipol go die like ram, sheep, goat or like big melu.
EZE 39:19 Wen I kill dis pipol as sakrifice, di birds and animals go chop evry part wey dem fit chop kon drink blood until dem nor fit drink again.
EZE 39:20 For my tabol, dem go chop all wetin dem fit chop from shariot and from all di sojas body.
EZE 39:21 God sey, “I go let di kountry si my glory and I go show dem how I dey judge well with my pawa.
EZE 39:22 Den from dat day go, Israel pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God.
EZE 39:23 All di kountries go know sey Israel go Babilon as slave, bikos of sin and I turn leave dem kon let dia enemies beat and kill dem for war.
EZE 39:24 I give dem wetin dem ask for and bikos of dia sin and wikedness, I waka leave dem.”
EZE 39:25 God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.
EZE 39:26 Wen dem don dey stay dia on land with peace and nobody dey treaten dem again, den dem go forget how dem sofa before wen dem dey sin against mi.
EZE 39:27 For all di enemies land where my pipol dey stay, I go bring dem kom back to dia own land, den evribody go know sey I dey holy.
EZE 39:28 Den my pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God. Dem go know, bikos I send dem go anoda land prisonas before, but naw, I don gada dem from all di kountries where I skata dem go before kon bring dem back to dia land and I nor forget or leave anybody for der.
EZE 39:29 I go pour my Spirit put for Israel pipol body and I nor go leave dem again.
EZE 40:1 Twenty-five years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di new year wey bi di fourteent year afta dem skata Jerusalem, God kon tosh mi with en hand and E take mi enter di town.
EZE 40:2 So, for inside vishon, God karry mi go Israel land kon put mi on-top one high mountin. For my front, I si sometin wey bi like one big town.
EZE 40:3 E take mi near am, den I si one man wey dey shine like bronze. E whole tape and stik wey dem take dey measure and e stand near di gate.
EZE 40:4 E kon tell mi, “Man pikin! Listin well-well and look evritin wey I dey show yu, bikos dis na di rizin why dem bring yu kom der, so dat yu go tell Israel pipol evritin wey yu si.”
EZE 40:5 I si wall wey dey round di temple for outside. Di man take en stik wey e take dey measure, wey long rish ten fit kon measure di wall. Di wall high and tick rish ten fit.
EZE 40:6 Den e klimb go di east gate go measure where dem dey pass enter and e deep rish ten and half fit.
EZE 40:7 For en front, e get one road wey pesin fit pass and three guard-room dey der. Each room na like skware wey bi ten and half fit and di wall wey separate dem tick pass eight fit. Afta di guard-room, anoda road dey wey long pass ten fit and yu go pass der go di big room wey face di temple.
EZE 40:8 Den e measure di room wey face inside and na ten and half fit.
EZE 40:9 E measure di room for di gate and na fourteen fit. And na dis room end di gate wey dey near di temple, but di end side for di wall tick pass three fit.
EZE 40:10 Three guide rooms dey for each gate and all of dem na di same size and all di wall wey separate dem, na di same tickness dem get too.
EZE 40:11 Den, di man measure as di road wide rish and evritin pass twenty-two fit, but di space wey dey between di gate na seventeen and di half fit.
EZE 40:12 For di guide rooms front, e get one wall wey high rish about two fit and dem tick rish ten and half fit.
EZE 40:13 Den e measure di distance from di back wall from one room go rish di room wey dey afta di road and e pass forty-three fit.
EZE 40:14 Pesin fit pass di ending room go where di kourt dey. E measure dat room and e high rish hundred fit.
EZE 40:15 So from outside di gate go rish di last room, e pass eighty seven fit and half.
EZE 40:16 Small-small whole dey di outside wall for all di rooms and di inside wall wey dey between di rooms. Dem karve palm trees for di inside wall wey face di road.
EZE 40:17 Di man karry mi pass di gate enter di kourt. Na thirty rooms dem build join di wall for outside and for dia front, e get one place where dem pak stone full
EZE 40:18 and e many round di kourtyard. Di kourtyard for outside low pass di inside.
EZE 40:19 E get one gate wey dem dey pass go di kourt for inside. E measure from di first gate go rish di sekond and na one hundred and seventy-five fit for di east and di nort.
EZE 40:20 Den di man measure di gate for nort wey yu go pass go di kourtyard.
EZE 40:21 Di three guard-room wey dey di passage side; di wall wey divide dem plus di big room, all of dem na di same size with doz wey dey for di east gate. Di gate lengt na eighty seven and half fit and e wide pass forty-three fit.
EZE 40:22 Di big room, di window and di tree wey dem karve put, bi like di ones wey dey di east gate. Na seven steps yu go pass before yu go rish di gate and di big room face di kourtyard for di end.
EZE 40:23 For di oda side for di kourtyard from di nort gate, anoda road dey wey dem dey pass go inside di kourt, just as e bi for di east. Di man kon measure how dem two far from each oda and na one hundred and seventy-five fit.
EZE 40:24 Den di man take mi go di sout-side and anoda gate dey der. E measure am and na di same size with di oda ones.
EZE 40:25 Windows dey di room for dis gate, just like di oda ones. Di lengt for dis gate pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit.
EZE 40:26 E get seven steps and di big room still face di kourtyard for di end. Palm tree wey dem karve for di wall wey dey inside, face di passage.
EZE 40:27 For der, e still get one gate wey dem fit pass go inside di kourtyard. Di man measure how e take far from di sekond gate and na one hundred and seventy-five fit.
EZE 40:28 Di man take mi pass di sout gate kon enter inside di kourt. E measure di gate and na di same size with di ones wey dey outside di kourt.
EZE 40:29 Di guard-room, di big room and di wall for inside na di same size with di ones wey dey di oda gates. Windows still dey der too.
EZE 40:30 Di total lengt long pass forty-three fit and e wide pass eight fit.
EZE 40:31 En big room face di oda kourtyard and dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
EZE 40:32 Di man take mi pass di east gate enter inside di kourtyard. E measure di gate and na di same size like di oda ones.
EZE 40:33 En guard-room, en big room and di wall for inside, na di same measurement like di oda gates. Windows still dey der and for di big room too. Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit.
EZE 40:34 Di big room face di kourt for outside. Dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
EZE 40:35 Den di man take mi go di gate for nort. E measure di gate and na di same size like di oda ones.
EZE 40:36 Like di odas, e still get guide rooms, walls wey dem design for inside, big room and windows for evriwhere: Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit.
EZE 40:37 Di big room face di kourt for outside. Dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
EZE 40:38 For di kourtyard for outside, e get one small room wey dem build join di gate for inside for di nort side. Yu fit from der go di big room wey face di kourt and na der dem for dey wosh di animals wey dem won burn as sakrifice.
EZE 40:39 For dis big room, four tabol dey der; two der for each side for di room. Na for dis tabol dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice; weda dem won burn or sakrifice am for sin or as ofrin.
EZE 40:40 For outside di room, four tabol wey bi like di same dey der, two-two for di side wey dem dey pass for di nort gate.
EZE 40:41 So, na eight tabol dey where dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice: four dey inside and four dey outside di room for di kourtyard.
EZE 40:42 Di four tabol for di small room where dem for dey prepare di ofrin wey dem won burn, na stone dem take make dem. Dem long pass two fit; wide pass two fit and high pass one fit. All di knife wey dem take dey kill di animals, dey on-top di tabols.
EZE 40:43 Di hooks wey dey di tabol na three inches dem long rish. All di meat wey dem go take do sakrifice dey dis tabol.
EZE 40:44 Den di man take mi enter di room for inside. E get two rooms for inside di kourt, one face sout near di nort gate and di oda one face nort near di sout gate.
EZE 40:45 Di man kon tell mi, “Di room wey face di sout na for di priest wey dey serve for di temple,
EZE 40:46 while di one wey face nort, na for di priest wey dey serve for di altar. All di priest na Zadok shidren-shidren; na dem bi di only pipol for Levi tribe wey fit go serve God for inside en temple.”
EZE 40:47 Di man measure inside di kourt and e wide and long rish one hundred and seventy-five fit. Di temple dey for di west side and di altar dey di temple front.
EZE 40:48 Den di man take mi enter di temple. E measure where dem dey pass enter and e deep pass eight fit and wide pass five fit.
EZE 40:49 Steps dey wey pesin dey pass go di room for inside wey long rish thirty-five fit and e almost wide rish twenty fit. Two marks dey der: One for each of di side where dem for dey pass enter.
EZE 41:1 Leta, di man take mi go di Holy Place for di centre room. E measure di passage wey dem dey pass enter: e deep rish ten and half fit for each side.
EZE 41:2 Wide rish eighteen fit and di wall for di two side almost tick rish nine fit. E measure di room and e long rish seventy fit kon wide rish thirty-five fit.
EZE 41:3 Den e go inside-inside di room kon measure di passage: e almost deep rish four fit kon wide rish ten fit and half and di wall for di two side tick pass twelf fit.
EZE 41:4 E measure di room and na thirty-five fit e bi. Dis room dey afta di room for centre. Den e kon tell mi, “Dis na di Most Holy Place.”
EZE 41:5 Di man measure as di temple wall bi and e tick rish ten fit. Round di wall for di temple, small-small rooms dey wey wide rish seven fit.
EZE 41:6 Di room dem dey three story building and each story get thirty rooms. Di wall for outside di temple tin pass di ones wey dey bottom, so dat dem go fit build di rooms make dem rest for di wall body.
EZE 41:7 So, wen yu si di temple wall for outside, e bi like sey na di same tickness e get go rish top. For outside di temple wall and di rooms, dem build two wide step for der where pesin go pass klimb go di middle house and di one wey dey up.
EZE 41:8 Di outside wall for dis rooms tick rish ten and half fit; e get one door wey dem take dey enter di rooms wey dey di nort side for di Temple
EZE 41:9 and one room dey to pass enter di sout-side for di temple too. I si sey di road to go di building so, wide rish eight fit
EZE 41:10 and di open space for di kourt wide rish thirty-five fit for all di side.
EZE 41:11 Between di road and di building wey di priest dey use, e get one open space wey almost wide rish nine fit.
EZE 41:12 For di end for di open space for di west side for di temple, e get one building wey long rish one hundred and fifty-seven and half fit and e wide rish one hundred and twenty-two and half fit; en wall tick rish nine fit.
EZE 41:13 Di man measure outside di temple and e long rish one hundred and seventy-five fit. So from di temple back go di open space go rish di west side for di building, na one hundred and seventy-five fit.
EZE 41:14 Di distance from di temple front plus di open space for di two side, na one hundred and seventy-five fit.
EZE 41:15 E measure di building lengt go rish di west; plus di bottom for di two side and na one hundred and seventy-five fit e bi.
EZE 41:16 Di passage wey dem dey pass enter di temple room, di Holy Place and di Most Holy Place, dem do dem with betta wood from groun go rish di window kon kover dem (dem kover di windows too),
EZE 41:17 go rish di space for outside and evriwhere for inside and outside wey dem measure.
EZE 41:18 Dem karve angel put for der kon design am with palm tree and palm tree still dey di two angel middle. Each angel wey dem karve get two face:
EZE 41:19 human being face wey dem draw face di palm tree for one side and lion face wey dem draw face di tree for di oda side. Na so dem karve dem for evriwhere for di temple;
EZE 41:20 from groun go rish di door-mot, dem karve and dekorate di angels for outside di temple too.
EZE 41:21 Na skware shape dem do put for di Holy Place door and dem resemble each oda.
EZE 41:22 For di road wey dem dey pass enter di Most Holy Place, e get sometin for der wey bi like altar wey dem do with wood. E high pass five fit and almost wide rish four fit. En korna; di base and en sides, na wood dem take make dem. Den di man tell mi, “Dis na di tabol wey dey God present.”
EZE 41:23 E get one door for where di passage for end for di Holy Place and one door still dey for di Most holy place.
EZE 41:24 Each door still get two-two small doors where pesin fit pass.
EZE 41:25 Dem karve angel and palm tree for di door for di Holy Place, just as dem karve for di walls. And e get one kanopy wey wood full for outside di room.
EZE 41:26 Na small-small windows wey dem dekorate with palm tree dey di wall. Dis na how di open space and di kanopy for di temple, bi like.
EZE 42:1 Den di man take mi go di kourtyard for outside and wi pass di building for di nort side for di temple wey nor far from di one wey dey di west side for di temple.
EZE 42:2 Dis building long rish one hundred and seventy-five fit for di nort side and wide rish eighty seven and half fit.
EZE 42:3 Opposite di space wey bi thirty-five fit wey dey for di kourt for inside and outside, dem build am as three story and dem face each oda.
EZE 42:4 For di nort side, dis building passage wide pass seventeen and half fit.
EZE 42:5 Naw, di room on-top di building small pass di ones wey dey middle and bottom, bikos e big pass di down and middle rooms,
EZE 42:6 bikos dem build dem as three story and dia pilas nor tick like di kourt own; so di top own nor tosh groun like di down and middle floor.
EZE 42:7 But for di outside wall for di building wey face di main door-mot, e long pass eighty seven fit.
EZE 42:8 Di room for di outside kourt long rish eighty seven and half fit, while di ones wey face di temple, long rish one hundred and seventy-five fit.
EZE 42:9 Under di rooms, for di east end for di building, na der di wall for start, e still get where dem dey pass enter di kourtyard for outside.
EZE 42:10 For der, e get one room wey resemble di rooms for di sout-side for di temple and dis room nor far from di rooms wey dey di west side for di temple.
EZE 42:11 For di rooms front, e get one passage wey bi like di one wey dey di nort side. E get di same measurement; di same design and na di same road, dem dey pass enter.
EZE 42:12 One door dey under di rooms for di sout-side for di building and for di east end where di wall for start.
EZE 42:13 Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.
EZE 42:14 Wen di priests enter di temple kom out and dem won go outside for di kourtyard, di holy klot wey dem wear take serve God, dem must leave am for dis rooms before dem komot. Dem must wear anoda klot before dem go-go where pipol gada dey wait dem.”
EZE 42:15 Wen di man don measure inside di temple finish, e take mi go outside thru di east gate kon measure outside di aria.
EZE 42:16 E measure di east side and na eight hundred and seventy-five fit.
EZE 42:17 Den e measure di nort side, di
EZE 42:18 sout-side and na eight hundred and seventy-five fit dem bi too.
EZE 42:19 E still measure di west side and all of dem na di same lengt wey bi eight hundred and seventy-five fit.
EZE 42:20 E measure dem from di four side. Di wall wey dey der, na to separate wetin dey holy from wetin nor dey holy and e long rish eight hundred and seventy-five fit and e still wide rish eight hundred and seventy-five fit too.
EZE 43:1 Di man take mi go di east gate
EZE 43:2 and I kon si Israel God glory dey kom from di east. God vois sound like nois from sea and en glory shine kover di eart.
EZE 43:3 Dis vishon bi like di one wey I si before wen God kom distroy Jerusalem and di one wey I si near Chebar River. Den I fall face groun.
EZE 43:4 God glory shine pass di east gate kon enter di temple.
EZE 43:5 Den God Spirit karry mi go inside di kourtyard and God glory full di temple.
EZE 43:6 Di man stand near mi and I hear wen God dey tok to mi from di temple sey:
EZE 43:7 “Man pikin, na my throne bi dis. I go stay here with Israel pipol kon rule dem forever. Di pipol for Israel or dia kings nor go disgrace my name wey dey holy again or woship anoda god or dia king wey don die.
EZE 43:8 Di kings build di door post and door-mot join my own and na di wall separate us. Na all dis bad tins wey dem dey do, make dem dey disgrace my name wey dey holy and I distroy dem, bikos I dey vex.
EZE 43:9 Naw, dem must stop to woship any oda god kon beri all doz kings dead body wey dem dey serve. If dem do like dis, I go stay with dem forever.”
EZE 43:10 God kon sey, “Man pikin, tell Israel pipol about di temple, so dat dem go undastand di plan. Make shame katch dem, bikos of di sin wey dem dey kommit.
EZE 43:11 Den, if shame don katch dem for wetin dem do, make yu tish dem about di temple plan: how en design bi; di door-mot; en shape; as dem take arrange evritin for der and all en rules and laws. Rite evritin give dem, so dat dem go fit read how dem arrange di temple kon do di rules and obey di laws.
EZE 43:12 “Dis na di temple law: All di aria wey dey near am on-top di mountin, der holy.
EZE 43:13 “Na di altar measurement bi dis, just as dem measure di temple: Di korna go high rish like two fit kon almost wide rish two fit, while di rim for outside, go long rish nine inches. Na so di altar go high rish.
EZE 43:14 Di size wey low pass from di altar go rish di top go almost high rish four fit. Di oda size for di altar go almost wide rish two fit and di small side go bi seven fit. Anoda part for di altar still get space wey almost rish two fit.
EZE 43:15 Di top part where dem for dey do sakrifice still high rish seven fit. Di four korna high pass all di remainin ones for di top.
EZE 43:16 Di altar top na skware and na twenty-one fit for each side.
EZE 43:17 Di middle part na skware too and e long pass twenty-four fit kon wide rish twenty-four and half fit for di four side; di korna go bi ten and half inches and di suroundin go bi about two fit. En step face di east side.”
EZE 43:18 God wey get pawa kon tell mi, “Man pikin, make yu listin to wetin I dey tell yu. Wen dem build di altar, yu go sakrifice animal put. Di animal wey dem sakrifice, yu go pour en blood put take dedikate am.
EZE 43:19 Doz priests wey kom from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren, na only dem go fit kom inside my present kom serve mi. Na mi, wey bi God wey get pawa dey kommand yu. Yu go give dem one yong melu make dem offa as sakrifice for sins.
EZE 43:20 Yu go take some of en blood kon put am for di four horn, di korna for di altar, di one for middle and round di korna dem. Like dis, yu go klean di altar kon make am dey holy.
EZE 43:21 Yu go take di melu wey dem offa as sakrifice for sin kon burn am for one place outside di temple aria.
EZE 43:22 “Di next day, yu go take one man goat wey dey okay kon offa am as sakrifice for sin. Yu go use en blood take klean di altar, just as yu do with di melu own.
EZE 43:23 Wen yu don do dat one finish, take one small melu and ram wey dey okay,
EZE 43:24 den bring dem kom meet mi. Di priest go pour salt for dia body kon burn dem as ofrin give mi.
EZE 43:25 “Each day for seven days, yu go offa one goat, one melu and one ram give mi as sakrifice for sin. All of dem must dey okay.
EZE 43:26 For seven days, di priests go klean di altar, so dat e go dey ready wen dem won use am.
EZE 43:27 Wen di seven days don finish, di priests go bring dia ofrin and di pipol ofrin kom. Den I go dey happy with all of una.
EZE 44:1 Den di man take mi go outside di gate for di east side for di temple aria. Dem klose di gate.
EZE 44:2 God kon sey, “From naw go, dem nor go ever open dis gate and as e dey so, na so e go dey. Dem nor go let human being use am, bikos mi di Oga wey bi Israel God, don pass am enter. E must dey klose like dat forever.
EZE 44:3 Di prince wey dey rule naw fit go der go chop di holy food for my present. E go enter kon pass di big room for inside, go out.”
EZE 44:4 Den di man take mi pass di gate for nort go di temple front. As I still dey look, I kon si God glory dey shine for di temple. At wons, I fall face groun
EZE 44:5 and God kon tell mi, “Man pikin, listin well-well to evritin wey yu hear and si. I go tell yu di rules and di laws for di temple. Listin well-well, so dat yu go know di pesin wey go fit enter and kom out from di temple and doz wey nor suppose enter.
EZE 44:6 Go tell doz bad pipol wey dey Israel sey, mi God wey get pawa nor go sorry for dem again, bikos of di yeye tins wey dem dey do.
EZE 44:7 Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do.
EZE 44:8 Dem nor dey kare for di holy place for my temple, instead na strenjas dey lead dem for my temple.
EZE 44:9 Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”
EZE 44:10 God tell mi, “I dey ponish Levi tribes wey join Israel pipol sin kon still woship juju.
EZE 44:11 Dem fit still serve mi for di temple kon stand for di gate den do di temple work. Dem fit kill di animals wey pipol kom offa as sakrifice and dem must dey to serve di pipol.
EZE 44:12 But bikos dem follow odas go serve juju kon make Israel pipol sin, mi God wey get pawa dey swear sey I must ponish dem.
EZE 44:13 Dem nor go serve as priest or go near anytin wey dey holy to mi or enter my Most holy place. Dis ponishment na for di yeye tins wey dem don do.
EZE 44:14 Na di work wey dem go do for di temple, I dey tell dem so.”
EZE 44:15 God wey get pawa sey, “All di priests from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren must kontinue to serve mi, even wen all di odas for Israel nor gri serve mi again. So naw, na dem go serve, enter my present kon offa di animals and di blood for di sakrifice, give mi.
EZE 44:16 Na only dem go enter my temple; serve mi for my altar kon lead odas to woship mi.
EZE 44:17 “Wen dem enter di gate where dem go pass go di kourtyard for inside di temple, dem must wear linen klot. Anytime dem dey work for di kourtyard or di temple, make dem nor wear anytin wey dem make with wool.
EZE 44:18 Dem must wear turban and linen trousers without belt, so dat dem nor go sweet.
EZE 44:19 Before dem go-go di kourt for outside where pipol dey, dem go first pul dia klot wey dem wear take work inside di temple kon leave am for di holy rooms. Dem go wear anoda klot, so dat dia holy klot nor go tosh pipol.
EZE 44:20 “Make priest nor barb en hair or let am grow too mush. Dem must let am grow rish one stage kon maintain am like dat.
EZE 44:21 Priests nor go drink any wine before e go inside di kourt.
EZE 44:22 Priests nor go marry woman wey nor dey with en husband again; na only Israel woman wey neva sleep with man before, e go marry or anoda priests wey don die, wife.
EZE 44:23 Na priests go tish my pipol di difren between wetin dey holy and wetin nor dey holy; wetin dey klean and wetin nor klean.
EZE 44:24 “Wen any kase dey kourt, na di priests go judge am akordin to my law. Dem go make sure sey dem kontinue di festival akordin to my rules and laws and dem must keep di Sabat Day holy.
EZE 44:25 “Anybody wey bi priest must nor tosh dead body, if not, e nor go dey klean again. Unless di dead body na en mama, papa, pikin, broda or sista wey neva marry before.
EZE 44:26 Afta e don dey klean again, e must wait for seven days
EZE 44:27 den kon go di kourt for di temple go offa sakrifice to klean ensef, so dat e go fit serve for di temple again.
EZE 44:28 “Na mi bi di priests propaty for life and una nor go give dem any propaty; I bilong to dem and evritin wey dem wont, na mi.
EZE 44:29 Di korn ofrin, di sin ofrin and all di oda ofrins; dem go bi di priests own and evritin for Israel wey di pipol give mi, go bi di priests own too.
EZE 44:30 Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house.
EZE 44:31 Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”
EZE 45:1 “Wen dem don divide di land kon give all di tribes for Israel dia share, dem go dedikate one part give God. E go almost long rish nine mile kon wide pass three mile. All dis aria go dey holy.
EZE 45:2 For dis aria, one skware go bi for di temple and na eight hundred and seventy-five fit for each side and e go get space wey wide rish eighty seven and half fit.
EZE 45:3 Half of dis aria go almost rish nine mile kon wide pass three mile; di temple wey bi di Holy Place, go dey inside.
EZE 45:4 E go bi di holy part for di kountry and na di priests go enter inside go serve God for en temple. Dia house go dey inside di kompond and my temple go dey der too.
EZE 45:5 Di oda half for di aria go bi Levi pipol own. Di pipol wey dey do di work for di temple and town, go get where dem go stay for der too.
EZE 45:6 Near di Holy Place, anoda place wey almost long rish three mile and wide rish eight and five mile, go dey for Israel pipol to stay too.
EZE 45:7 “Land go dey for di prince wey dey rule. E go get from di boundary for west for di holy aria go rish Mediterranean Sea and from di boundary for east go rish di east borda for di kountry and di lengt go bi di same with di one of di land wey dem give Israel tribe.
EZE 45:8 Dis aria go bi di prince wey dey rule Israel own, so e nor go opress di pipol again and di remainin part for Israel go bi di tribes own.”
EZE 45:9 God wey get pawa sey, “Una wey bi ruler for Israel, na since una dey sin! Make una stop una wahala and opreshon. Make una dey do di rite tin. Una nor go ever drive my pipol komot from dia land again. Na mi wey bi Oga una God dey tok so.
EZE 45:10 Evribody must measure well So from naw go, make evribody dey measure well.
EZE 45:11 Di basket wey dem dey use measure dry tins, must dey ekwol with di one wey dem take dey measure wota and na di normal size una go use. Di result for di measurement na: one size must ekwol ten basket and ten baskets must ekwol one bag.
EZE 45:12 Na so una weigh suppose bi: twenty gerahs must ekwol one shekel and sixty shekels must ekwol one mina.
EZE 45:13 “Dis na how yu go take give yor ofrins: Wheat: go bi one for evry six wey yu harvest, Barley: go bi one for evry six wey yu harvest,
EZE 45:14 Olive oil go bi one for evry ten wey yu produce from yor trees. (Den make yu measure am with di bottol: 10 bottol na one normal size and e must ekwol one gallon.)
EZE 45:15 Sheep go bi one out of evry two hundred wey dey Israel. Una go bring rice ofrin, animal wey dem go burn and animal for di fellowship ofrin, so dat I go forgive una sins. Mi God wey get pawa don kommand.
EZE 45:16 All di pipol for di land go take dis ofrin go give di prince wey dey rule Israel naw.
EZE 45:17 Na en work to bring di animal wey dem go burn, di korn ofrin for di New Moon Festival, di Sabat Day and di oda festivals. Na en go provide di ofrin for sins; di korn ofrins, di full animal wey dem go burn as ofrin and di fellowship ofrin, so dat God go forgive Israel pipol dia sins.”
EZE 45:18 God wey get pawa sey, “For di first day for di first mont, yu go sakrifice one melu wey dey okay kon klean di temple.
EZE 45:19 Di prince go take some of di blood kon put am for di four korna for di altar door-mot and di door-mot wey dem dey pass enter di main kourt.
EZE 45:20 For di sevent day for di mont, yu go do di same tin for di pipol wey sin and dem nor know sey dem sin. Like dis, yu dey make di temple dey holy.
EZE 45:21 “For di fourteent day for di first mont, yu go start to celebrate di Passova Feast. For seven days, evribody go chop bread wey nor get yist.
EZE 45:22 For di first day wey di festival start, di prince wey dey rule go offa one melu as sakrifice for en sins and for di pipol sins.
EZE 45:23 For each of di seven days for di festival, e go sakrifice seven ram wey dey okay kon burn dem give God. Evriday, e go still sakrifice one goat as ofrin for sins.
EZE 45:24 For evry melu and ram wey e go sakrifice, half bag of rice and three kwota of olive oil, must dey as ofrin.
EZE 45:25 For di Festival wey go start for di Fifteent day for di seven mont, di prince go offa di same sakrifice for sin for dat seven days. E go burn di same ofrin kon give di same korn and olive oil.”
EZE 46:1 God wey get pawa sey, “For di six days for di week wen una take dey work, make dem dey always klose di east gate wey dem dey pass enter di kourtyard, but make dem open am for Sabat Day and for di New Moon Festival.
EZE 46:2 Di prince wey dey rule go pass outside di kourt enter di big room kon stand near di door-mot wen e won burn di sakrifice and offa di fellowship ofrin. For di gate der, e go woship God kon go out back. Dem must nor lock di gate till evening.
EZE 46:3 For evry Sabat Day and New Moon Festival, all di pipol must bow woship God for di gate for front.
EZE 46:4 For Sabat Day, di prince go offa six sheep and one ram as sakrifice give God and all di animals must dey okay.
EZE 46:5 For one ram, e go karry half bag of korn follow am as ofrin and for one sheep, e go take anytin wey e fit take go as ofrin. For evry half bag of korn ofrin, e go karry three kwota of olive oil follow body.
EZE 46:6 For di New Moon Festival, e go take one yong melu, six sheep and one ram and all of dem must dey okay.
EZE 46:7 For one melu and ram, e go take half-half bag of korn follow body as ofrin and for di sheep, di ofrin go bi anytin wey e like to offa. For evry half bag of korn ofrin, e go karry three kwota of olive oil follow body.
EZE 46:8 Di prince must komot from di big room for di gate kon go back just as e take kom.
EZE 46:9 “Wen dem dey do festival and di pipol kom woship God, anybody wey pass di nort gate enter go use di sout gate go out afta dem don woship finish and doz wey enter thru di sout gate go pass di nort gate komot. Make nobody go out thru di gate wey e take enter, but make e pass di opposite gate kom out.
EZE 46:10 Di prince go kom inside wen di pipol don kom and e go komot wen di pipol don go.
EZE 46:11 “For di festival, di korn wey dem go offa go bi half bag with one melu and ram and anytin wey di pipol won give with dia ram. For evry half bag for di korn ofrin, dem go karry three kwota of olive oil follow body.
EZE 46:12 Wen di prince won kom just give God ofrin from en mind, weda na burnt or fellowship ofrin, dem go open di east gate where dem dey pass enter di kourtyard, for am. E go give di ofrin just as e dey offa am for Sabat Day and wen e don go out, dem go must klose di gate.”
EZE 46:13 God sey, “For evry morning, una go burn one sheep pikin wey bi one year as ofrin give mi and e go dey okay. Na evriday una go dey do dis ofrin.
EZE 46:14 Una go still dey give mi five pound of flower evry morning with one kwota of olive oil wey dem mix with flower. Una must kontinue to give dis ofrin forever.
EZE 46:15 Evry morning, una go offa di sheep pikin, di flower and di olive oil give God as ofrin forever.”
EZE 46:16 God wey get pawa sey, “If di prince wey dey rule give any of en land to en son as gift, dat land go bi di pikin own forever.
EZE 46:17 But if di prince wey dey rule give any of en land to en savants, e go bi di savant propaty until wen Freedom Year go rish, before e go bi di prince own again. Na-im and en son get en propaty dem forever.
EZE 46:18 Di prince wey dey rule nor go take any propaty wey nor bi en own. Any land wey e give en son must bi from di land wey bi en own, so dat e nor go opress any of my pipol or take dia land.”
EZE 46:19 Den di man take mi go front of di room wey face di nort, near di gate for di sout-side for di inna kourt. Dis na di holy room for di priests. E show mi one place for di west side for di room
EZE 46:20 kon sey, “Dis na di place where di priest go boil di meat, wey dem go offa as sakrifice for sin ofrin and na der dem go for bake di bread too, so dat dem nor go karry anytin wey dey holy go outside di kourt kon kause trobol for di pipol by mistake.”
EZE 46:21 Den e karry mi go outside for di kourt kon take mi pass di four korna for di kourt and each side for di four korna get kourt
EZE 46:22 wey long rish seventy fit and wide rish fifty-two and half fit.
EZE 46:23 Each of dem get stone round am and dem still get where dem for dey boil di ofrins under am.
EZE 46:24 Den di man kon tell mi, “Na dis bi di kishin where di temple savant go for boil di sakrifice meat wey di pipol offa.”
EZE 47:1 Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar.
EZE 47:2 Di man take mi pass di nort gate and wi kom out from di temple gate wey face east. And wota dey flow kom out from di sout-side for di gate.
EZE 47:3 As di man waka go di east side with en tape, e measure 1,000 and seven hundred and fifty fit, and e sey make I waka pass am. Di wota rish mi for my leg.
EZE 47:4 Den e measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit kon sey make I enter and di wota kon rish mi for my knee. E measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit and dis time di wota kon rish my waist.
EZE 47:5 E still measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit, den di wota kon turn river and I nor fit cross am. E too deep to cross escept yu sabi swim.
EZE 47:6 E kon tell mi, “Man pikin, yu don si dis tin before?” Den di man take mi go back to di wotaside
EZE 47:7 and wen I rish der, I si sey many trees dey di wotaside.
EZE 47:8 E tell mi, “Dis wota dey flow go di east, den from der go Jordan River Valley kon enter di Dead Sea. Afta di wota don flow go di Dead Sea wey get salt taste, di sea go kon turn to fresh wota.
EZE 47:9 Anywhere di wota flow go, animals and fish wey dey dat place, go still dey alive. Di wota go make di Dead Sea wota fresh and anywhere dis wota flow go, evritin for der, go get life.
EZE 47:10 For En-Gedi go rish En-Eglaim wota, pipol dey go der go katch fish. Dem dey katch difren fish for der just as dem dey katch for Mediterranean Sea.
EZE 47:11 But di wota wey dey flow pass and di ones wey dey di bush side, nor fresh at-all, bikos e dey taste like salt.
EZE 47:12 For each side for di river, difren trees dey grow for der. Dia leaf nor go dry and dia fruit nor go fall, but dem go dey produce good food evry mont and dia leaf go dey cure doz wey dey sick, bikos di wota wey dey survive dem dey flow kom from di temple.”
EZE 47:13 God wey get pawa sey, “Dis na di land wey yu go divide among di twelf tribes for Israel. But Josef tribe go get two.
EZE 47:14 Yu must divide am ekwol, bikos I promise una grand-grand papa sey di land go bi dia own.
EZE 47:15 “Dis go bi di land boundary and e go bi from di nort side go di Mediterranean Sea kon rish Hetlon town and from Hamat Pass go Zedad town;
EZE 47:16 from Berotah and Sibraim (wey dey between Damaskus and Hamat kingdom) go rish Tikon town (wey dey di boundary for Hauran kingdom).
EZE 47:17 Di boundary go start from di Mediterranean sea go rish Hazar Enon town with Damaskus and Hamat boundary for nort.
EZE 47:18 Di boundary for east na from sout between Damaskus and Hauran with Jordan River wey bi boundary between Israel land for west and Gilead for east go rish Tamar for di Dead Sea.
EZE 47:19 Di boundary for sout na from sout-west for Tamar go rish Kadesh Meribah; den go rish nort-west along Egypt boundary for Mediterranean Sea.
EZE 47:20 Di west boundary na from Mediterranean Sea go rish di nort side for west wey bi Hamat Pass.
EZE 47:21 “So, make yu divide dis land among di tribes for Israel.
EZE 47:22 Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.
EZE 47:23 Each strenja for di land go kollect dia share with di tribe wey dem dey stay with.
EZE 48:1 “Naw, dis na di tribes name: From nort near Hetlon to Lebo-Hamat go rish Hazar-Enan (wey bi Damaskus boundary near di nort side for Hamat) wey wide from east go rish west. Dan tribe go get one part.
EZE 48:2 From Dan boundary for east go rish west, Asher tribe go get one part.
EZE 48:3 From Asher boundary for east go rish west, Naftali tribe go get one part.
EZE 48:4 From Naftali boundary for east go rish west, Manasseh tribe go get one part.
EZE 48:5 From Manasseh boundary for east go rish west, Efraim tribe go get one part.
EZE 48:6 From Efraim boundary for east go rish west, Reuben tribe go get one part.
EZE 48:7 For Reuben boundary for east go rish west, Judah tribe go get one part.
EZE 48:8 “Di oda part for di land, una go keep am well. E go almost wide rish nine mile from nort go sout and e go get di same lengt from east go west, just as dem give each tribe. Di temple go dey for dis space.
EZE 48:9 Di land wey una keep for God so, go almost long rish nine mile kon wide rish like four mile.
EZE 48:10 Dis na how una go divide di holy aria: di priests land go long rish eight and one kwota mile from west kon wide rish three and kwota mile; e go bi di same measurement from nort go sout. God temple go dey di aria centre.
EZE 48:11 Dis holy aria go bi for di priest wey bi Zadok shidren-shidren. Na dem dey serve mi and dem nor join Israel pipol sin against mi, just as Levi tribe do.
EZE 48:12 So dem go get one special aria near Levi pipol and na der go dey holy pass.
EZE 48:13 “Levi shidren go get special place for der and e go dey di sout-side near di priests. E go long rish nine mile kon wide like three and kwota mile for west; di measurement na di same from nort go rish di sout-side.
EZE 48:14 Di aria wey dem leave for God, must bi di best part for di land and make dem nor sell, shange am or gi-am to anybody. Bikos e dey holy and na God get am.
EZE 48:15 “Di part wey remain for di special aria, wide rish one and kwota mile kon long like eight and one-kwota mile. So make una stay and use der as una like for di town. Di town go dey for di centre
EZE 48:16 and each side go bi one and half mile.
EZE 48:17 Di town go get enough space, each side go long and wide rish four hundred and thirty-seven and half fit.
EZE 48:18 Di land wey remain for di town, afta dem don build house put and di holy aria, na four hundred and thirty-seven and half mile for di east and four hundred and thirty-seven and half mile for di west and di pipol wey dey stay di town go use am do farm.
EZE 48:19 Anybody wey dey stay di town, no matter en tribe or who e bi, fit farm for di land.
EZE 48:20 So di total aria for di centre wey remain, go bi eight and one kwota mile skware for each side and di aria where di town dey, join dat measurement too.
EZE 48:21 “Apart from di east go rish di west for dis aria where di temple dey, di priests land, di Levi land and where di town dey, na di prince wey dey rule get di remainin land.
EZE 48:22 Di land na from east go di boundary; from west go Mediterranean Sea; di nort aria wey bi Judah own and di sout-side wey bi Benjamin own.
EZE 48:23 “As for di rest tribes: from di east side go rish di west side, Benjamin tribe go get one part.
EZE 48:24 From Benjamin boundary for east go rish di west, Simeon tribe go get one part.
EZE 48:25 From Simeon boundary for east go rish di west, Issakar tribe go get one part.
EZE 48:26 From Issakar boundary for east go rish di west, Zebulun tribe go get one part.
EZE 48:27 From Zebulun boundary for east go rish di west, Gad tribe go get one part.
EZE 48:28 From di sout-side wey dem share give Gad, di boundary go bi from: di sout-west from Tamar go rish Kadesh and from nort-west along Egypt boundary go rish Mediterranean Sea.
EZE 48:29 Dis na di share for di land wey yu go give Israel tribes and e go bi dia own.
EZE 48:30 “Na twelf gates go dey Jerusalem and three-three go dey di wall for di four side for di town. Wen dem measure di nort side, na one and half mile e bi.
EZE 48:31 Dem koll di gates for di town afta Israel tribe; three gates dey nort: one for Reuben, one for Judah and di last one for Levi tribe.
EZE 48:32 For di east side, e rish one and half mile and na three gates go dey here too: one for Josef, one for Benjamin and di oda one for Dan tribe.
EZE 48:33 Wen dem measure di sout-side, na one and half mile and na three gates dey der too: one for Simeon, one for Issakar and di last gate for Zebulun.
EZE 48:34 Di west side long rish one and half mile and three gates go dey der too: one for Gad, one for Asher and di last one, go bi for Naftali tribe.
EZE 48:35 Di total lengt for di wall for di four side for di town go bi six mile. So, from dat day go, dem go dey koll di town: ‘God Dey Der.’ ”
DAN 1:1 For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.
DAN 1:2 God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
DAN 1:3 Den di king kommand Ashpenaz wey dey guide di kourt sey make e choose some Israel men wey kom from royal house and from betta family:
DAN 1:4 yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.
DAN 1:5 Di king still orda sey make dem give dem di same food and wine wey en and di oda pipol dey chop and drink evriday. E sey dem go train dem for three years and afta di three years, dem go kom serve di king.
DAN 1:6 Di pipol wey dem choose from Judah na: Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya.
DAN 1:7 But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
DAN 1:8 But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.
DAN 1:9 So God kon make Ashpenaz mind soft and e gri with wetin Daniel tell am.
DAN 1:10 So e tell Daniel, “I dey fear my masta di king. Na-im tok di kind food wey una go chop and wine wey una go drink; wot of if e sey yu dey tin and di oda yong men dey fat! Wetin I go tell am?
DAN 1:11 Den Daniel go meet di pesin wey Ashpenaz sey make e dey guide en, Hananaya, Mishael and Azaraya kon tell am:
DAN 1:12 Abeg make yu test yor savants for ten days. Just give us vegitabol make wi chop and wota make wi dey drink.
DAN 1:13 Afta di ten days, make yu kompare us with di odas wey dey chop and drink di king food and wota; den yu go judge us with wetin yu si.”
DAN 1:14 Di pesin wey dey guide dem so kon gri with wetin e tok and e test dem for ten days.
DAN 1:15 Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.
DAN 1:16 So di pesin wey dey guide dem kon remove di royal food and wine wey di king sey make dem chop, den dem kontinue to chop dia vegitabol and drink wota.
DAN 1:17 God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.
DAN 1:18 Afta three years, Ashpenaz kon take all di yong men go meet King Nebukadnezzar.
DAN 1:19 Den di king follow dem tok. E nor si anybody wey bi like Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya. So dem kon bi memba for di king kourt.
DAN 1:20 Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
DAN 1:21 Daniel stay for di royal house until di first year wen King Cyrus start to rule.
DAN 2:1 For di sekond year wen Nebukadnezzar dey rule, e kon dream many dreams. Di dreams dey disturb en mind and e nor fit sleep,
DAN 2:2 so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.
DAN 2:3 But di king sey, “I nor fit remember wetin I dream and I nor know wetin di dream mean.”
DAN 2:4 Di wise men kon tell di king for Aramaik language sey: “Awa king, make yu live forever! Make yu tell yor savants di kind dream wey yu dream and wi go tell yu wetin e mean.”
DAN 2:5 Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house!
DAN 2:6 But if una fit tell mi di dream and wetin e mean, I go give una gifts. I go reward and honor una. So make una tell mi di dream and wetin e mean.”
DAN 2:7 Dem tell di king again, “Abeg! Make yu tell us yor dream and wi go tell yu wetin e mean.”
DAN 2:8 Di king ansa, “I know sey una dey try to waste time, bikos una si sey I don tok wetin I go do.
DAN 2:9 If una nor tell mi di dream naw, na only one tin go happen to una. Una dey plan to lie give mi, bikos una bilive sey I fit shange my mind leta. So make una tell mi di dream and I go know sey una fit tell mi wetin e mean.”
DAN 2:10 Di wise men tell di king, “Nobody for dis world fit tell di king wetin e dream and know king don ever do dis kind tin to majishan, wise men or pipol wey dey si vishon.
DAN 2:11 Wetin di king dey ask for, nor dey eazy. Nobody for dis world fit tok di king dream escept di gods, but gods nor dey stay with human being!”
DAN 2:12 Bikos wetin dem tok make di king vex, e kon sey make dem kill and distroy all di wise men wey dey for Babilon.
DAN 2:13 So dem make law to kill all di wise men and Daniel and en friends dey join doz wey dem won kill so.
DAN 2:14 Den, Daniel go meet Ariok wey dey kommand di king bodyguard and na-im won kill dem. So e tok to am with wisdom.
DAN 2:15 E ask am, “Wetin make di king take dis kind wiked decision?” Den Ariok tell Daniel wetin happen.
DAN 2:16 Den Daniel go tell di king sey make e gi-am time and e go tell di king di dream and en meaning.
DAN 2:17 Daniel go house go tell e friends, Hananaya, Mishael and Azaraya wetin dey happen.
DAN 2:18 E kon ask dem to pray to God wey dey heaven make E for sorry for dem kon show dem di dream and en meaning, so dat en and en friends nor go die with di oda-wise men for Babilon.
DAN 2:19 For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven
DAN 2:20 kon sey, “Make wi praiz God name forever and ever, bikos na-im get wisdom and pawa.
DAN 2:21 Na-im dey shange time and sizin; dey make and distroy kings. E dey give wisdom, undastandin and knowledge to wise pipol.
DAN 2:22 All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.
DAN 2:23 I praiz and honor Yu, di Oga wey bi my papa dem God. Yu don give mi wisdom and pawa; Yu don ansa my prayers kon show mi wetin I go tell di king.”
DAN 2:24 So Daniel go si Ariok (wey di king don tell make e kill di wise men for Babilon). E kon tell am, “Make yu nor kill di wise men for Babilon! Just take mi go meet di king and I go tell am en dream and wetin e mean!”
DAN 2:25 So Ariok kwik-kwik take Daniel go meet di king kon sey, “I don si one man wey wi karry kom from Judah, e go tell yu yor dream and wetin e mean.”
DAN 2:26 Den di king kon ask Daniel (wey en name na Belteshazzar), “Yu go fit tell mi di dream wey I dream and wetin e mean?”
DAN 2:27 Daniel ansa, “Di dream wey di king dream so, na dat kind dream wey wise men, pesin wey dey si vishon and majishan, nor go fit tok.
DAN 2:28 But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:
DAN 2:29 “As yu dey sleep for yor bed, yu kom dey tink of di future. God wey dey show pipol dream, don show yu wetin go happen.
DAN 2:30 Naw, God tell mi dis dream nor bi bikos na mi wise pass, but na to make yu my king, undastand wetin yu dey tink for yor mind.
DAN 2:31 “My king, for yor vishon, yu si one big image wey stand for yor front! E dey shine well-well and fear nor let yu look am.
DAN 2:32 Na gold dem take make di image head; en chest and hand na silva, while from en belle go down, na bronze.
DAN 2:33 En leg na iron, but en toe na both iron and san-san.
DAN 2:34 As yu dey look, one hand wey nor bi human being own kon kut one stone. Di stone fall on-top di image iron leg and di image kon skata to pieces.
DAN 2:35 Den all di iron, gold, silva and bronze kon bi like san-san for dry sizin. Breeze blow kon karry all of dem go and dem nor si dem again. But di stone wey skata di image, grow turn to mountin kon kover di eart.
DAN 2:36 Dis na di dream. Naw I go tell my king wetin e mean:
DAN 2:37 “My king, yu get pawa pass any oda king. God wey dey for heaven don make yu leader kon give yu pawa, strent and honor.
DAN 2:38 E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.
DAN 2:39 But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.
DAN 2:40 Den, di nomba four kingdom go kom and e go strong like iron wey go skata evritin to pieces. E go skata and distroy all di kingdoms wey dey before.
DAN 2:41 Yorsef si di leg and di toe wey dem make with iron and san-san. Dis one mean kingdom wey divide into two. Some of en pawa go bi like iron, aldo dem mix di iron with san.
DAN 2:42 Di toes wey dem make with iron and san mean sey, wen di kingdom don dey old, some part go strong and some part go weak.
DAN 2:43 Di san and iron wey mix togeda still dey show sey dis kingdom go try gada oda pipol join demsef thru marriage, so dat dem go dey strong, but dem nor go fit stay togeda just as iron and san nor fit mix.
DAN 2:44 For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
DAN 2:45 My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”
DAN 2:46 Den King Nebukadnezzar bow face groun kon sey make dem sakrifice and offa ofrin for Daniel.
DAN 2:47 Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”
DAN 2:48 So di king give Daniel high post with many fine gifts. E gi-am pawa for evry aria for en kingdom kon make am leader ova all di wise men for Babilon.
DAN 2:49 Daniel beg di king make e promote Shadrak, Meshak and Abednego, so dat dem go dey handle some issues for Babilon. Daniel, ensef kon dey serve for di king palis.
DAN 3:1 King Nebukadnezzar build one gold image. E tall rish ninty fit and na so too e wide rish nine fit. Di king put di image for Dura aria for Babilon.
DAN 3:2 Di king sey, doz wey bi offisa, prince, govnor, judge, wise men, kounselor, treasurer, magistrate and doz wey get pawa, make dem koll dem kom di image dedikashon.
DAN 3:3 So all of dem gada kom di king image dedikashon. Dem stand for di image front.
DAN 3:4 Den di pesin wey dey announce kon shaut sey: “Pipol from all nashon, tribe and language, make una listin to mi!
DAN 3:5 Wen una hear trumpet sound wen dem dey play di horn, lyre, jita, zita, harp with di oda instrument and di song, evribody must bow kon woship di image wey di king use gold make.
DAN 3:6 Anybody wey nor gri bow woship di gold image, dem go trow am inside hot fire.”
DAN 3:7 So, as dem hear music and all di oda instrument sound, di pipol kon bow woship di gold image wey Nebukadnezzar make.
DAN 3:8 For dat time, some Babilon pipol kon go ripot di Jew dem give di king.
DAN 3:9 So, dem tell King Nebukadnezzar, “Awa king, make yu live forever!
DAN 3:10 Yu orda sey, wons wi hear di music dey play, evribody must bow kon woship di gold image
DAN 3:11 and anybody wey nor gri bow woship di image, dem go trow am inside fire.
DAN 3:12 E get some Jew wey yu put as oga for some aria for Babilon, dem nor gri bow woship di image and dia name na: Shadrak, Meshak and Abednego.”
DAN 3:13 Wen di king hear wetin dem tok, e vex kon sey make dem go bring di three men kom en front.
DAN 3:14 Wen Shadrak, Meshak and Abednego kom, di king ask dem, “Na true sey una nor gri woship or bow to di image wey I make?
DAN 3:15 So naw, if una don ready, wons una hear di trumpet, di horn, lyre, jita, harp and all di oda instrument sound, make una bow woship di image. If una nor gri, na wons I go trow una enter di fire. Abi una tink sey any god dey wey go save una?”
DAN 3:16 Shadrak, Meshak and Abednego ansa King Nebukadnezzar, “Wi nor fit ansa yu for dis matter.
DAN 3:17 If di God wey wi dey serve dey alive, E go kom save us from yor hand and from di hot fire.
DAN 3:18 But even if E nor save us, wi wont make yu know sey, wi nor go serve or woship yor gold image.”
DAN 3:19 King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.
DAN 3:20 E sey make strong sojas tie Shadrak, Meshak and Abednego kon trow dem inside di hot fire.
DAN 3:21 Dem tie di three men, wear dem klot, nika and priest kap kon trow dem inside di hot fire.
DAN 3:22 Bikos di king kommand too dey kwik and di fire dey hot pass normal, di men wey go trow dem for inside di fire die too, bikos of di way di fire dey hot.
DAN 3:23 Shadrak, Meshak and Abednego wey dem tie dia hand and leg well-well, fall enter di fire centre.
DAN 3:24 King Nebukadnezzar get up at wons kon ask, “Shebi na three pipol wi trow inside di fire?” Dem ansa di king, “Yes.”
DAN 3:25 Di king kon tell dem, “But I dey si anoda pesin for der, dem nor tie am and e just dey waka round di fire! Nor-tin don happen to dem! And di nomba four pesin bi like angel!”
DAN 3:26 Nebukadnezzar waka near di fire door kon koll dem, “Shadrak, Meshak and Abednego; God Almighty savants, make una kom out!” Den Shadrak, Meshak and Abednego kon waka komot from di hot fire.
DAN 3:27 Di offisa, wise men, govnor and ministers wey dey serve di king, gada kon si sey di men wey dem trow for di fire, nor wound at-all! Nor-tin even tosh dia hair or sey dia klot burn. Even di fire sef nor smell for dia body!
DAN 3:28 Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’
DAN 3:29 Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”
DAN 3:30 So Nebukadnezzar kon promote Shadrak, Meshak and Abednego.
DAN 4:1 King Nebukadnezzar send message go meet all di pipol for Babilon sey: “Make e betta for una!
DAN 4:2 I dey happy to tell una di many signs and wonders wey God Almighty don do for mi.
DAN 4:3 “Di sign dem wey E show us dey great well-well! Even en wonders dey mighty! God kingdom go dey forever and en pawa go last from awa generashon go rish di next one.”
DAN 4:4 Mi wey bi Nebukadnezzar dey live for peace for my palis, I dey enjoy betta tins.
DAN 4:5 But I dream one bad dream wey make mi fear. Wetin I dey tink as I sleep for my bed and di vishon for my mind really make mi fear well-well.
DAN 4:6 So I orda make dem koll all di wise men for Babilon, so dat dem go tell mi wetin di dream mean.
DAN 4:7 Wen di majishan, pipol wey dey si vishon, wise men and odas kom, I kon tell dem di dream, but nobody among dem fit tell mi wetin e mean.
DAN 4:8 Afta, Daniel (wey en name na Belteshazzar wey bi my god name and di holy gods spirit dey with) kon enter. So I tell am my dream sey:
DAN 4:9 “Belteshazzar, na yu bi di majishan dem oga; I know sey di gods spirit dey inside yu and e nor get any dream or vishon wey yu nor know en meaning. I go tell yu my dream and yu go tell mi wetin e mean!
DAN 4:10 Dis na di dream wey I dream: Wen I dey sleep for nite, I si one tree wey dey di land centre.
DAN 4:11 “E tall rish di sky and yu go si am for anywhere wey yu dey for dis world.
DAN 4:12 Di tree leaf fine well-well and fruits wey go beleful evribody, full am. Wild animals dey stay under am and birds dey stay for en branches dem. Evritin wey God kreate, dey chop from am.
DAN 4:13 Wen I still dey tink about dis dream, I kon si one angel dey kom down from heaven.
DAN 4:14 E shaut kon sey, ‘Make una kut di tree kon distroy en branches; remove en leaf and skata en fruits. Make una drive di animal komot from under am and di birds wey dey en branches!
DAN 4:15 But leave di body for groun kon kover am with iron and bronze. Leave am for der with di grass; make dew wet am and make e stay with di animals and grass.
DAN 4:16 Make e stop to tink like human being. Make dem gi-am animal mind and e go dey like dat for seven years.
DAN 4:17 Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’
DAN 4:18 “Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”
DAN 4:19 Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!
DAN 4:20 Di tree wey yu si, wey grow big and strong rish heaven, wey dem fit si from any part for di world.
DAN 4:21 Tree wey get fine leaf and fruit wey go beleful evribody wey dey di world and where wild animals and birds dey stay,
DAN 4:22 na yu, my king! Yu don dey big and strong; yu don big sotey yu dey rish di heaven and yor pawa rish di end for di world.
DAN 4:23 For di dream, yu si angel kom out from heaven kon sey, ‘Make una kut and distroy di tree, but make una leave di body for groun. Make una kover am with iron and bronze. Make una leave am for der with di grass, so dat dew wey dey fall from di sky go wet am, den make e stay with animals for bush.’ ”
DAN 4:24 Dis na wetin e mean, “My king! Na wetin di Most High God tok, dey happen so.
DAN 4:25 Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.
DAN 4:26 Wen dem sey make dem leave di tree body for groun, e mean sey dem go give yu back yor kingdom wen yu don know sey na God bi Oga of all ogas for dis world.
DAN 4:27 So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”
DAN 4:28 So, all dis tins happen to King Nebukadnezzar.
DAN 4:29 Afta twelf monts, as e dey waka for di roof for en palis for Babilon.
DAN 4:30 E kon sey: “Dis nor bi di great Babilon wey bi di royal town wey I build by mysef to show my pawa, strent, glory and honor?”
DAN 4:31 As e still dey tok, one vois kom from heaven kon sey: “King Nebukadnezzar, make yu hear wetin I dey tok, God don komot yor kingdom from yor hand!
DAN 4:32 Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”
DAN 4:33 So, di word wey God tok about Nebukadnezzar kon happen. Dem drive am komot from where human being dey and e kon go stay with animals. E chop grass like melu for seven years and dew fall for en body, until en hair kon long like eagle feada and en finger long like bird own.
DAN 4:34 But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.
DAN 4:35 Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”
DAN 4:36 Wen my mind don kom back to mi, dem kon give mi back my kingdom, pawa and glory. My ministers and royal men welkom mi back and dem give mi my royal pawa and di honor wey I kom get, big pass di first one.
DAN 4:37 Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
DAN 5:1 King Belshazzar do party for en royal men wey rish 1,000 and e kon drink wine togeda with dem.
DAN 5:2 As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine.
DAN 5:3 So, dem bring di gold cup and di bowl kom and dem use am take drink wine
DAN 5:4 kon dey praiz dia god wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone.
DAN 5:5 At wons, one finger appear kon dey rite for di palis wall near where di lamp for dey shine well-well and di king si di hand wey dey rite for di wall.
DAN 5:6 Bikos e dey fear, en face kon dey red and all en body kon dey shake.
DAN 5:7 Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”
DAN 5:8 So di wise men kom, but dem nor fit read wetin dem rite or tell di king wetin e mean.
DAN 5:9 Dat time, King Belshazzar kon dey fear well-well and shake anyhow, but en royal men nor even know wetin dem go do.
DAN 5:10 Bikos of di many nois wey dem dey make, di king mama enter di hall kon sey, “My king, yu go live forever! Abeg nor let dis tin shake yor mind and make yu nor fear!
DAN 5:11 E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon.
DAN 5:12 E get one kind pawa with knowledge and wisdom. E dey solve problem wey pesin nor know. E go tell yu wetin dream or vishon mean; so make yu send for dis man, dem dey koll am Daniel wey di king shange en name to Belteshazzar and e go tell yu wetin di writing mean.”
DAN 5:13 So dem bring Daniel kom meet di king. Den di king ask am, “Na yu bi di Daniel wey my papa bring kom from Judah?
DAN 5:14 I don hear about yu; how di holy gods spirit dey inside yu and yor knowledge, wisdom and undastandin.
DAN 5:15 Si, dem bring di wise men and majishan kom here make dem read wetin dey di wall kon tell mi wetin e mean, but dem nor fit read am tok-less of to know di meaning.
DAN 5:16 Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”
DAN 5:17 But Daniel ansa, “My king! Make yu keep yor gifts kon honor anoda pesin. But I go read wetin dey di wall kon tell yu wetin e mean.
DAN 5:18 Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty.
DAN 5:19 Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace.
DAN 5:20 But e kom dey karry body up, dey sturbon and pride kon full en spirit, so God remove am from en throne and e kom lost en respet.
DAN 5:21 Dem porshu am komot for where human being dey. En mind kom bi like animal own and e kon dey follow wiked donkeys dey stay. E dey chop grass like sey e bi melu kon dey sleep for bush and e nor get anytin to take kover en body from dew wey dey fall. Na so e bi until e kom bilive sey na God dey rule ova human being and dey give leadership to anybody wey E like.
DAN 5:22 “But yu, Belshazzar wey bi Nebukadnezzar pikin, neva gri respet God, even doh sey yu know all dis tins wey happen.
DAN 5:23 Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!
DAN 5:24 Na dis make God send di hand kom rite all dis words for di wall.
DAN 5:25 “Dis na wetin di hand rite: MENE, MENE, TEKEL and FARSIN (E mean, NOMBA, NOMBA, WEIGH, DIVISION).
DAN 5:26 And dis na wetin e mean: mene (nomba) mean sey: ‘God don nomba di days wey yu go rule and E go end am.’
DAN 5:27 Tekel (weigh) mean sey: ‘God don weigh yu for skale kon si sey yu dey lite.’
DAN 5:28 Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”
DAN 5:29 Just as di king tok, dem kon wear royal purpol klot give Daniel; put gold shain for en neck kon make am di nomba three man for Babilon.
DAN 5:30 So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king.
DAN 5:31 Darius wey bi Media pipol king kon take-ova di kingdom and dat time, e bi sixty-two years.
DAN 6:1 Darius choose one hundred and twenty govnors wey go kare for di whole kingdom.
DAN 6:2 Den di king choose three pesin wey go dey shek wetin di govnors dey do and Daniel dey among di three wey dey make di govnors do wetin di king wont.
DAN 6:3 Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom.
DAN 6:4 So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.
DAN 6:5 So dem kon sey, “Wi nor go si anytin wey wi fit take whole Daniel, unless sey na sometin wey koncern en God.”
DAN 6:6 So dem go meet King Darius kon tell am, “Awa king! Make yu live forever!
DAN 6:7 All of us wey dey rule yor kingdom, doz wey dey wosh wetin wi dey do; di kounselor, wise men and all di oda royal men, don gri sey make yu give orda kon back am with pawa sey, ‘For thirty days, anybody wey pray to any god or human being wey nor bi yu, make dem trow am for lions pit.’
DAN 6:8 Abeg, awa king, make yu give and sign dis orda, so dat nobody go fit shange am and e go bi like Mede and Persia Law wey nor dey shange.”
DAN 6:9 So King Darius give and sign di orda.
DAN 6:10 Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday.
DAN 6:11 Wen Daniel enemies know sey e dey pray to God,
DAN 6:12 all of dem gada go meet di king kon tell am, “Awa king! Shebi yu sign orda sey for thirty days make anybody nor pray give human being or gods escept yu and yu sey who pray give any oda god, make dem trow am for lion pit?” Di king ansa, “Una dey korrect! E dey for Mede and Persia Law and dem nor go fit shange am.”
DAN 6:13 So dem tell di king, “Daniel, wey bi one of di pipol wey dem bring kom from Judah, nor gri respet di king orda at-all. Na three times a day, e dey pray give anoda God.”
DAN 6:14 Wen di king hear wetin dem tok, e nor happy and e kon try to save Daniel komot from dia hand. Until aftanoon dat day, e still dey find how e go take save Daniel.
DAN 6:15 Daniel enemies tell di king, “Awa king! Yu know sey Mede and Persian Law sey, any orda wey di king give, nobody go fit shange am.”
DAN 6:16 So di king sey make dem go trow Daniel for di lion pit. Di king tell Daniel, “Yor God wey yu dey serve evritime, go save yu!”
DAN 6:17 Dem remove di stone from di pit mout and di king put en own royal seal with en royal men own, so dat nobody go kom save Daniel.
DAN 6:18 Den di king go back to en palis. But for nite, di king nor fit chop, sleep or sey make dem play music for am.
DAN 6:19 As day just break, di king kon rush go di lion pit.
DAN 6:20 As e rish der, e kon shaut, “Daniel, God wey nor dey die savant! Di God wey yu dey serve fit save yu?”
DAN 6:21 Daniel kon ansa di king from di pit, “My king, yu go live forever!
DAN 6:22 My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”
DAN 6:23 Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve.
DAN 6:24 Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.
DAN 6:25 King Darius kom rite give all di pipol, nashon and language wey dey di land sey: “I greet una!
DAN 6:26 I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.
DAN 6:27 E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”
DAN 6:28 Wen Darius still dey rule for Babilon and Cyrus dey rule for Persia, Daniel kom prosper well-well.
DAN 7:1 Di first year wen Belshazzar bi king for Babilon, Daniel dream one kind dream kon si plenty vishon wen e dey sleep, so e rite di dreams for book.
DAN 7:2 Daniel sey: “As I dey dream dat nite, I kon si breeze dey blow from di four korna for di eart and di sea dey make strong nois.
DAN 7:3 Den four big beast kom out from di sea and dem dey difren from each oda.
DAN 7:4 “Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.
DAN 7:5 “Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’
DAN 7:6 “Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.
DAN 7:7 “As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.
DAN 7:8 “As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
DAN 7:9 “As I still dey look, dem kom set throne and Oga God wey nor dey die kon sidan put. En klot dey white like snow and en hair bi like lamb skin. En throne dey bring fire like sey di wheel dey burn.
DAN 7:10 River with fire dey kom out from di throne. Pipol wey dey woship am, many well-well. Many-many pipol still dey wait to kom woship am. Den dem open di book, bikos dem won start to judge kase.
DAN 7:11 “I still dey look as di horn dey tok wiked-wiked words. I dey look until dem kill di beast kon distroy en body, den trow am inside di fire wey dey kom out from di throne.
DAN 7:12 Dem take di remainin beast pawas, but dem sey make doz beast still dey live for sometaim.
DAN 7:13 As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.
DAN 7:14 Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
DAN 7:15 “Di vishon wey I si dey disturb mi.
DAN 7:16 So I go meet one of dem wey stand for der kon tell am make e tell mi wetin e mean. Den e tell mi di meaning.
DAN 7:17 E sey, ‘Di four big beast na four kingdom wey go soon kom di eart.
DAN 7:18 And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’
DAN 7:19 “Den, I won kon know more about di nomba four beast wey nor bi like any of di oda beast; di beast wey dey make pesin fear; wey dey kill and skata wetin e fit skata with en bronze finger and iron tit.
DAN 7:20 I still won know about di ten horns for en head; di horns wey grow kom out leta; di three horns wey fall wey get eye and mout wey dey tok anyhow and en face dey make pesin fear pass any of di oda beast dem own.
DAN 7:21 As I still dey look, di horn kon dey fight and distroy God pipol,
DAN 7:22 until God wey dey live forever kon judge and favor all en holy shidren. Den di time kom rish for God to take-ova di kingdom.
DAN 7:23 “Dis na wetin e tell mi: ‘Di nomba four beast mean sey di eart go get four kingdom wey go difren from all di kingdoms wey dey before. Dem go skata and distroy di eart.
DAN 7:24 “ ‘Di ten horns mean di ten kings wey go kom from dat kingdom. Anoda king go kom afta dem, but e go dey difren from all di former kings. E go ova-trow three kings.
DAN 7:25 E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
DAN 7:26 “ ‘But di kourt for heaven go sidan judge am kon take en pawa komot for en hand, den dem go distroy am finish.
DAN 7:27 Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’
DAN 7:28 “Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”
DAN 8:1 For di third year wey King Belshazzar dey rule, mi Daniel si anoda vishon apart from di ones wey I don si before.
DAN 8:2 For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river,
DAN 8:3 I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one.
DAN 8:4 I si di ram dey waka with en horn dey go west, nort and sout-side. No animal fit stop am or eskape from en pawa. E dey do wetin e like and dey bihave anyhow.
DAN 8:5 As I still dey tink, one man goat kon dey kom from west side. E dey run fast-fast like sey en leg nor dey tosh groun. E get one horn between en two eyes.
DAN 8:6 E rush kon attack di ram wey I si before, wey stand near di river.
DAN 8:7 I dey look as e vex kon attack di ram, den e break di ram two horns and di ram nor get pawa to fight am back. Di goat trow di ram for groun kon dey mash am and nobody fit save am.
DAN 8:8 Di goat kon dey strong more-more, but leta, en horns kon break. Den four horns kon grow kom out from where di two horns for break and each of di horns face difren direcshon.
DAN 8:9 From one of di horn, anoda small horn kon grow kom out. E grow big well-well kon face sout, east and di promise land.
DAN 8:10 E strong rish to attack God sojas for heaven; e even remove and trow some stars for groun kon stand on-top dem.
DAN 8:11 E still dey praiz ensef pass di sojas for heaven. E stop di sakrifice wey dem dey offa give God evriday kon skata where dem for dey woship God.
DAN 8:12 Instead of di normal sakrifice wey di pipol dey offa, dem kon start to sin, so dem forget God ways. Di horn dey enjoy evritin wey e dey do.
DAN 8:13 Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?”
DAN 8:14 I kom hear di oda angel sey, “Na 2,000 three hundred days, both for morning and evening and for dat time, dem nor go offa any sakrifice.”
DAN 8:15 As I still dey try to undastand wetin di vishon mean, I kon si pesin stand for my front.
DAN 8:16 Den I hear vois from Ulai river dey sey, “Gabriel, make yu tell am di meaning of wetin e si.”
DAN 8:17 Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”
DAN 8:18 As e dey tok to mi, I kon faint for groun. But e tosh mi and I get up.
DAN 8:19 So e sey, “I kom tell yu wetin go happen wen trobol go dey for di world. Dis vishon na about wen di world won end.
DAN 8:20 Di ram wey yu si wey get two horn, na di two kings for Mede and Persia.
DAN 8:21 Di man goat na Greece king and di big horn wey dey between en eyes, na di first king.
DAN 8:22 Di horn wey break wey four oda horns kon grow kom out for en place, na di four oda kingdoms wey go kom from en nashon, but dem nor go get pawa like am.
DAN 8:23 Wen dia kingdom don dey won end and dia sin don plenty well-well, anoda wiked king wey sturbon and dey lie well-well, go kom ponish dem.
DAN 8:24 E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God.
DAN 8:25 With en wayo, e go prosper as e dey lie and deceive pipol. E go dey bihave anyhow kon distroy many pipol without sey e first warn dem. E go fight and win kings wey get strong pawa, but e go skata wen nobody tosh or fight am.
DAN 8:26 Di vishon about morning and evening wey dem tell yu, korrect. But make yu keep di vishon for yor mind, bikos di time wey e go happen, neva rish.”
DAN 8:27 So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.
DAN 9:1 For di first year wen Zazes pikin, Darius wey bi Media king, dey rule Babilon.
DAN 9:2 For dat same year wen e dey rule, mi Daniel kom undastand di holy book wey sey na seventy years God tell Profet Jeremaya sey, Jerusalem pipol go skata for di world.
DAN 9:3 So I wear sak klot, sidan for ashes den turn to God kon dey beg am as I dey pray and fast.
DAN 9:4 I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey: “God! Yu get pawa well-well and wi dey honor Yu. Yu dey keep yor promise and Yu love pipol wey love and dey obey Yu.
DAN 9:5 Wi don sin! Wi wiked well-well and wi dey do bad tins. Wi nor dey do wetin Yu kommand and wi don turn from yor korrect way.
DAN 9:6 Wi nor gri listin to yor savants wey bi profets; di ones wey tell awa kings, rulers, grand-grand papa and all di nashon about Yu.
DAN 9:7 “Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.
DAN 9:8 My God! Wi dey sofa like dis, bikos awa king, rulers and grand-grand papa, don sin against Yu.
DAN 9:9 But even with all di sin wey wi kommit, Yu still dey forgive and sorry for us.
DAN 9:10 Wi nor dey obey di Oga awa God, bikos wi nor dey live awa life as E sey make wi leave am. Wi even bilive sey di law wey E sey make en savants tell us, nor mean anytin.
DAN 9:11 “All of us don break yor law and wi nor gri listin to wetin Yu tok. Wi don sin and na awa sins make Yu dey ponish us so, just as yor savant, Moses rite am for di law.
DAN 9:12 Yu don do wetin Yu sey Yu go do wi and awa leaders. For all di towns wey dey for dis world, na Jerusalem Yu dey ponish pass.
DAN 9:13 Yu dey ponish us just as dem rite am for Moses Law. But as Yu ponish us rish, wi still dey kommit sin and wi nor gri do wetin Yu tok.
DAN 9:14 Awa Oga God dey ready to ponish us and E really ponish us, bikos anytin wey E dey do, dey rite, yet wi nor gri listin to am.
DAN 9:15 “Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.
DAN 9:16 Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.
DAN 9:17 “So naw, God, make Yu hear my prayer and as I dey beg Yu. Make Yu sorry for yor temple wey dem don distroy; so dat evribody go know sey na only Yu bi di God wey nor dey die.
DAN 9:18 Abeg, God make Yu sorry for Jerusalem town wey Yu choose, nor bi bikos wi deserve am, but bikos of yor great love wey nor dey fail.
DAN 9:19 So make Yu forgive us! Make Yu kwik hear and ansa us. Nor bi just for yor town and en pipol, but na to make pipol honor and praiz yor holy name.”
DAN 9:20 As I still dey pray, dey konfess and beg God make E forgive mi and Israel pipol sin kon sorry for en holy temple,
DAN 9:21 Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.
DAN 9:22 Di angel tell mi, “Daniel, I don kom make yu really undastand naw.
DAN 9:23 God don ansa yor prayer since di very first day wen yu start to pray and beg am and na di love wey E get for yu, make mi kom so. Naw, make yu listin well-well as I dey tok kon undastand di vishon:
DAN 9:24 “God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.
DAN 9:25 “So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.
DAN 9:26 “ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.
DAN 9:27 “ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”
DAN 10:1 For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
DAN 10:2 Before dat time, mi, Daniel dey mourn for three weeks.
DAN 10:3 I nor chop any good food, meat, drink wine or komb my hair until di three weeks komplete.
DAN 10:4 For di twenty fourt day for di first mont, I stand near di great river, wey dem dey koll Tigris.
DAN 10:5 I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz.
DAN 10:6 En body bi like yellow jasper and en face dey shine like lite. En eye dey shine like tosh; en hand and leg bi like bronze wey dem polish. En vois alone bi like sey na many pipol dey tok.
DAN 10:7 Na only mi, Daniel si di vishon. Di men wey follow mi nor si am. Dem run go hide, bikos dem dey fear.
DAN 10:8 Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi.
DAN 10:9 But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun.
DAN 10:10 Den one hand tosh and karry mi stand up well; but I still dey shake.
DAN 10:11 Di angel kom tell mi, “Daniel! God love yu. Stand up make yu listin well-well to wetin I won tok naw, bikos na God send mi kom meet yu.” Wen e don tok finish, I kon stand up, even doh I still dey shake.
DAN 10:12 Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer.
DAN 10:13 Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia.
DAN 10:14 Naw, I don kom help yu undastand wetin go happen to yor pipol for di future, bikos dat na wetin di vishon dey tok-of.”
DAN 10:15 As di angel still dey tok to mi, I sleep for groun and I nor fit tok.
DAN 10:16 Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
DAN 10:17 I bi like savant wey stand for en oga front. Naw, how I won take tok to yu? I nor get strent to even breath again.”
DAN 10:18 Den di angel tosh mi again and my body kon strong.
DAN 10:19 E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”
DAN 10:20 Di angel sey, “Yu know wetin make mi kom meet yu? Naw, I won go fight Persia prince. Wen I don go, di angel wey dey guide Greece go kom.
DAN 10:21 “But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.
DAN 11:1 Den for di first year wen Darius bi king for Mede, I kom help and defend am.)
DAN 11:2 And na di trut I won tell yu naw.” Di angel still sey, “Three more king go kom from Persia. Den di fourt king go get money well-well pass all di kings wey don dey before am. Wen e don get pawa well-well, bikos of en money, e go karry evribody go fight Greece.
DAN 11:3 Anoda king wey get money go kom. E go rule many great kingdoms kon do wetin e like.
DAN 11:4 But en kingdom go skata at wons go di four korna for di world and four oda kingdoms go raiz and nor bi en shidren or family pipol go rule dis pipol and di kingdoms nor go get pawa like en own.
DAN 11:5 “Den Egypt king go get pawa well-well. But one of en sojas oga go even strong pass am and e go rule great kingdom.
DAN 11:6 Afta many years, Egypt king go make agriment with Siria king kon give en dota to am as wife. But di agriment know go last, bikos dem go kill di girl, en husband, en pikin and di savants wey follow am go.
DAN 11:7 “E nor go tey before one of di woman broda, go bi king. E go attack Siria king, dia sojas, enter di place wey strong pass kon kill dem.
DAN 11:8 E go karry dia juju and all dia betta tins with silva and gold go back to Egypt. Afta many years wey peace don dey,
DAN 11:9 Siria king go attack Egypt, but e nor go susid.
DAN 11:10 Siria king sons go dey ready to fight and dem go gada many sojas. One of dem go flow like wota kon attack dia enemies strong town.
DAN 11:11 “Egypt king go vex well-well kon go fight Siria king and e go katch many of en sojas.
DAN 11:12 E go dey happy for en viktory and all di many sojas wey e kill, but e nor go always dey win.
DAN 11:13 Siria king go-go back go gada many sojas wey plenty pass di first ones. Den for di rite time, e go attack with all en sojas wey dem don prepare well-well.
DAN 11:14 “Dat time, many pipol go kom oppoz Egypt king. And some of di wiked ones from yor nashon go raiz to show sey dis vishon na trut, but dem go skata.
DAN 11:15 Den Siria king go katch and take one strong town. Di sojas wey dey Egypt nor go fight again; even di best sojas wey dey with dem nor go get pawa again.
DAN 11:16 Siria sojas go do wetin dem like and nobody go oppoz dem. E go stand for di promise land and en pawa go dey komplete.
DAN 11:17 Siria king go plan to travel with en sojas and all of dem go get one mind. Den make e for fit distroy en enemy kingdom, e go enter agriment with dem kon give en dota to dem as wife; but en plan nor go work.
DAN 11:18 Den e go attack and konker many nashons wey dey near di sea. But one ruler from anoda kountry go win am kon stop all di nonsense wey e dey do since. All di yeye tins wey Siria king don do, di ruler go do am to am too.
DAN 11:19 Di king go-go back to en land wey dem protet well, but e go stagga fall and dem nor go si am again.
DAN 11:20 Anoda king go raiz wey go send en ofisas go opress pipol. Dem go kollect tax for dia hand kon make dia kingdom get plenty money. E nor go tey before dem go kill-am, but nor bi for publik or war.”
DAN 11:21 “Di angel still sey di next king for Siria go wiked well-well. E nor get rite to bi king, but before pipol know, e go deceive dem kon bi king.
DAN 11:22 Anybody wey ask am kweshon about di High Priest, e go kill-am.
DAN 11:23 E go deceive many oda nashons, bikos e sey e dey make peace and e go dey strong evriday, even doh en nashon nor big.
DAN 11:24 E nor go warn towns wey get money before e attack dem and e own go worse pass wetin en grand-grand papa dem do. E go divide di propaty wey e take for war give en men. E go plan to attack sojas wey strong pass am, but en time go soon end.
DAN 11:25 E go raiz many sojas wey go attack Egypt king wey don prepare to fight back with en strong and pawaful sojas. But dem go deceive Egypt king and e go luz di war.
DAN 11:26 Di pipol wey dey chop with di king, go plan to kill-am! Dem go kill and skata many of en sojas.
DAN 11:27 Di two kings go sidan chop for di same tabol, even doh dem get bad belle for each oda; dem go dey deceive each oda. Dem nor go get wetin dem won get, bikos di time neva rish.
DAN 11:28 Den Siria king for nort go-go house with all di tins wey e karry for war. En mind go dey against di holy kovenant. E go kause wahala, den e go-go e own land.
DAN 11:29 Leta, e go attack Egypt, but dis time, e nor go bi like di first one.
DAN 11:30 Kittim pipol go kom with ship kon fight am and fear go katch am. E go turn won kon distroy God pipol. Den e go-go back kon favor doz wey rijet di holy kovenant.
DAN 11:31 En sojas go skata di temple. Dem go stop di sakrifice wey dem dey do kon do many bad tins.
DAN 11:32 Doz wey don rijet di kovenant, e go use sweet mout take win dem back, but doz wey dey follow God, nor go allow am.
DAN 11:33 Doz wey wise among di pipol go tish di odas. But some of dem go die for war and dem go karry di rest go as prisonas.
DAN 11:34 God go help en pipol small wen dem fall. But some pipol go play wayo kon join dem.
DAN 11:35 Even some wey wise go die and dis tin go kon make di pipol klean. E go kontinue like dis until di end rish; di time wey God don set.
DAN 11:36 “Den di king go do wetin e like. E go dey make mout and karry body up sey, ‘I get pawa pass any oda god. I even high pass God wey dey heaven.’ E go dey susid until di time wey God won ponish am, don rish. God go do wetin E don plan.
DAN 11:37 Di king nor go respet en papa gods, tok-less of di god wey wimen love. E nor go respet any god, but e go dey karry ensef up.
DAN 11:38 Na only di gods wey get pawa well-well, e go dey respet. Gods wey en papa nor know, na-im e go honor with gold, silva, fine stones and propaty.
DAN 11:39 E go attack strong nashons wey dey woship anoda god. E go honor pipol wey si am as dia leader. Dem go serve for en ofis and e go give dem land as dia reward.
DAN 11:40 “Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
DAN 11:41 Den e go enter di fine land. Many pipol go die, but di leaders for Edom, Moab and Ammon go eskape.
DAN 11:42 E go attack oda kountries and even Egypt nor go fit eskape am.
DAN 11:43 E go kontrol where dem hide gold and silva put with all di betta tins wey Egypt, Libya and Ethiopia bin get.
DAN 11:44 Den, dem go gi-am trobol from nort and east and e go-go fight with all en pawa kon distroy and kill many pipol.
DAN 11:45 E go even build small palis for di sea centre near di holy mountin. But wen e go die, nobody go dey der to help am.”
DAN 12:1 “Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.
DAN 12:2 Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.
DAN 12:3 But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.
DAN 12:4 “But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”
DAN 12:5 Mi, Daniel, kom si two men stand for di oda side. Dem stand for di river two side.
DAN 12:6 One kon tell di oda one wey wear linen, wey dey on-top di river, “Wen all dis wonderful tins go happen?”
DAN 12:7 Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”
DAN 12:8 I hear wetin e tok, but I nor undastand. So I kom ask, “Wetin go happen afta all dis tins?”
DAN 12:9 E ansa, “Daniel! Make yu dey go. Dis matter don finish and dem don keep am until di world go end.
DAN 12:10 Many pipol go dey klean; dem go klean dem well-well, but wiked pipol go still dey do dia wikedness. No wiked pesin go undastand naw, but na only wise pipol, go fit undastand.
DAN 12:11 E go bi 1,000 two hundred and ninty days, from di time wey dem stop di sakrifice kon start all dis bad and wiked tins, wey dem dey do.
DAN 12:12 Pipol wey dey faithful until di 1,000 three hundred and thirty-five days don end, go dey happy!
DAN 12:13 But Daniel, make yu dey faithful to di end. Yu go die, but wen di world don end, yu go raiz-up kon kollect yor reward.”
HOS 1:1 Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
HOS 1:2 Wen God first tok to Israel pipol thru Hosea, E tell am, “Make yu go marry ashawo and just as my pipol don leave mi and nor dey faithful to mi, na so too yor wife nor go dey faithful to yu and e go born shidren wey nor go know dia papa.”
HOS 1:3 So Hosea go marry one girl wey bi Diblaim pikin and en name na Gomer. Afta dem don born dia first pikin wey bi boy,
HOS 1:4 God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.
HOS 1:5 Dat time, I go distroy Israel sojas for Jezrel Valley.”
HOS 1:6 Gomer, Hosea wife kon born anoda pikin, but dis time, na girl. Den God tell Hosea, “Yu go koll dis one, ‘Lo-Ruhamah wey mean: No-pity,’ bikos I nor go show Israel pipol love or forgive dem again.
HOS 1:7 But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”
HOS 1:8 Afta Gomer don stop to breast feed Lo-Ruhamah, e kon get belle again and e born anoda boy.
HOS 1:9 So God tell Hosea, “Make yu koll dis one, ‘Nor bi my pipol (Lo-Ammi),’ bikos Israel pipol nor bi my pipol and I nor bi dia God.”
HOS 1:10 But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”
HOS 1:11 Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!
HOS 2:1 Den make yu go koll yor brodas, “Ammi” (wey mean “My pipol”)! And yor sistas, “Ruhamah” (wey mean “Pity”)!
HOS 2:2 Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again.
HOS 2:3 If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.
HOS 2:4 I nor go pity or sorry for en shidren, bikos na ashawo wey nor get shame, born dem.
HOS 2:5 Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.”
HOS 2:6 But I go fence and block una mama with shuku-shuku, so dat e nor go waka go anywhere.
HOS 2:7 E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”
HOS 2:8 But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.
HOS 2:9 So for harvest time, I go take all my gifts wey bi korn, wine, wool and linen wey I gi-am make e wear.
HOS 2:10 I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa.
HOS 2:11 I go stop all di party and feast wey e dey do evry mont, year and for Sabat Day.
HOS 2:12 I go distroy all en vine and di fig tree wey e sey en lovers gi-am, bikos e dey serve dem. I go turn en gardins to wildaness; den wiked animals go distroy dem.
HOS 2:13 I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear.
HOS 2:14 I go karry am go wildaness kon make am turn kom meet mi with di sweet-sweet words wey I go tell am.
HOS 2:15 I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.
HOS 2:16 For dat time, na husband yu go dey koll mi instead of yor masta.
HOS 2:17 I go remove Baal name from yor mout and yu nor go ever take about am again.
HOS 2:18 For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.
HOS 2:19 Israel, I go make yu my wife; I go love and dey faithful to yu; I go always sorry for yu and yu go bi my own forever.
HOS 2:20 I go keep my promise kon make yu my own, den yu go know sey na mi bi yor God.
HOS 2:21 For dat time, wen my pipol Israel pray to mi, I go ansa dem.
HOS 2:22 I go make rain fall and korn, grape and olive fruit go grow for di land.
HOS 2:23 I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”
HOS 3:1 God tell mi, “Make yu go love yor wife again, even doh e love anoda man and dey sleep with difren pipol. Na so too God love Israel pipol, even doh dem turn kon dey serve oda gods and dey give dia rice as ofrin to juju.”
HOS 3:2 So I pay fifteen silva koin and seven basket for barley to take bring di woman back.
HOS 3:3 Den I tell am, “Yu must always dey with mi and nor do ashawo or go sleep with anoda man again and mi mysef go dey with yu.”
HOS 3:4 Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.
HOS 3:5 But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.
HOS 4:1 Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey: “For dis land, nobody love mi, dey faithful or si mi as en God.
HOS 4:2 Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.
HOS 4:3 So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”
HOS 4:4 God sey, “Make nobody akuiz or blame di pipol, bikos na una wey bi priests, I dey tok against.
HOS 4:5 Una go fall for day time and una wayo profets go fall with una for nite, den I go distroy una mama Israel.
HOS 4:6 My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
HOS 4:7 As di priests dey plenty, na so dia sin against mi, dey plenty too. So I go turn dia honor to disgrace.
HOS 4:8 Bikos dem dey make money from my pipol sin, dem kon dey kommit more sin.
HOS 4:9 Dem go sofa di same ponishment with di pipol! I go ponish and make dem pay for di evil and wiked tin wey dem do.
HOS 4:10 Even wen dem chop food, dem nor go beleful; dem go dey sleep with each oda, but dem nor go born pikin, bikos dem don turn from di Oga God kon dey follow oda gods.”
HOS 4:11 God sey, “Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem nor get sense again.
HOS 4:12 Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.
HOS 4:13 Dem dey offa sakrifice on-top mountin kon burn incense for di hills and under evry tall tree, bikos dem dey enjoy di shade! Bikos of dis, una dotas dey do ashawo and una dota in-law dey sleep with oda pipol husband.
HOS 4:14 I nor go ponish una dotas wen dem dey do ashawo or una dota in-law wen dem dey sleep with anoda pesin husband, bikos di men for di temple dey make sakrifice and sleep with ashawo too. So, pipol wey nor get sense, na distroshon go end dia life.
HOS 4:15 But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi, make una, Judah pipol nor bihave like dem. Make una nor go woship for Gilgal or Bethel or use God name take make promise for der.
HOS 4:16 Just as melu sturbon, na so Israel pipol bi. So, how I go fit take feed dem like lamb wey dey for open field?
HOS 4:17 Bikos of di juju wey Efraim pipol dey serve, curse dey dia head. So make una nor go near dem!
HOS 4:18 Afta dem don drink plenty wine, dem go-go sleep with ashawo; bikos dem like disgrace pass honor.
HOS 4:19 So, breeze go karry dem go and dem go shame sey dem dey offa sakrifice give juju.”
HOS 5:1 “Una wey bi priest, make una listin! Israel pipol, make una listin well-well! Una wey kom from royal family, make una listin well-well too bikos I dey kom judge una. Una lead di pipol enter trap bikos all of una dey woship juju for Mizpa and for Mount Tabor.
HOS 5:2 Una don dig one deep pit for where una dey woship juju, so I go ponish all of una.
HOS 5:3 I know Israel pipol well-well; di wiked tins wey dem do, nor go fit hide from mi. Dem don turn ashawo kon make demsef dirty.
HOS 5:4 “Dia wikedness nor allow dem turn kom meet mi wey bi dia God, bikos di juju wey dem dey serve, dey shark dem and dem nor won know mi at-all.
HOS 5:5 Israel pipol sturbones dey tok against dem. Dia sin dey make dem kick stone fall and Judah pipol dey fall with dem too.
HOS 5:6 Even wen dem kom sakrifice animals give God make E for favor dem, dem nor si am bikos E don turn from dem.
HOS 5:7 Dem nor dey faithful to God and dem born shidren wey nor know dia papa. So naw, di new moon festival go distroy dem and dia land.
HOS 5:8 “Make una blow di war trumpet for Gibeah! Make una blow di wiso for Rama! Make una blow di trumpet for Bet-Aven! Benjamin pipol make una shake with fear!
HOS 5:9 Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!
HOS 5:10 “God sey, “Judah leaders bi like pipol wey dey kut pipol land take. So I go pour my vexnashon like heavy rain for dia body.
HOS 5:11 Dem go opress and judge Israel pipol anyhow, bikos dem don make up dia mind to serve juju.
HOS 5:12 I go distroy Israel kon turn Judah land to where dem dey trowey dirty put.
HOS 5:13 Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.
HOS 5:14 I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.
HOS 5:15 I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”
HOS 6:1 Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.
HOS 6:2 Afta two or three days, E go heal us, so dat wi go fit stay for en present again.
HOS 6:3 So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
HOS 6:4 But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.
HOS 6:5 Na dis make mi send my profet kom give una di judgement and distroshon message. Just as day dey break for morning, na so too, my judgement go kom meet una.
HOS 6:6 Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.
HOS 6:7 But just like Adam, my pipol sef break di kovenant wey I make with dem.
HOS 6:8 Na wiked pipol full Jabesh-Gilead town and na pipol blood kover all dia street.
HOS 6:9 Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!
HOS 6:10 I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.
HOS 6:11 As for una Judah pipol, I don set time wen I go take ponish una bikos of una sins, even doh sey I go make my pipol prosper again.”
HOS 7:1 “Wen ever I sey I won heal and make my pipol, Israel prosper again, dia wikedness and di bad-bad tins wey dem dey do, nor dey allow mi do am. Samaria pipol dey shit each oda and dey do bad tins. Dem dey break enter pipol house and dey tif waka for street.
HOS 7:2 Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.
HOS 7:3 Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
HOS 7:4 All of dem dey sleep with who dem nor marry. Dia body dey hot like oven wey dem won take bake bread, bikos of di bad tins wey dem won do.
HOS 7:5 Wen di king dey do party, en and en ofisas dey drink well-well and dem go dey make plans with yeye pipol.
HOS 7:6 Yes, dia plan dey burn like hot oven. Dia vexnashon dey hot well-well for nite and wen dey break, e go rush kom out like fire.
HOS 7:7 All of dem dey burn well-well like oven; dey kill dia rulers one-by-one and yet, dem nor gri kom meet mi make I for help dem.”
HOS 7:8 God sey, “Efraim pipol bi like bread wey nor don. Dem don join and put hope for di towns wey dey round dem
HOS 7:9 and dem nor know sey na dis trust wey dem get for strenjas, distroy dia pawa. And naw, wahala dey kom, but dem nor know.
HOS 7:10 Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.
HOS 7:11 Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!
HOS 7:12 But as dem dey waka up-and-down, I go trow net wey go katch dem like bird. I go ponish dem for di evil tins wey dem don do.
HOS 7:13 Dia own don finish! Dem don forget mi kon dey do wetin I sey make dem nor do, so I go distroy dem. I won save dem before, but dem nor dey woship mi from dia heart.
HOS 7:14 Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
HOS 7:15 Even doh sey na mi train and make dem strong, dem still plan against mi.
HOS 7:16 Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”
HOS 8:1 “Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.
HOS 8:2 Even doh dem sey I bi dia God and dey klaim sey dem bi my pipol wey know mi. But naw, Israel pipol dey beg mi sey, ‘Make Yu kom help us bikos Yu bi awa God!’
HOS 8:3 But e don late well-well, bikos dem don rijet wetin dey good, so dia enemies go porshu dem well-well.
HOS 8:4 Na only my pipol choose king and leaders demsef without sey I permit dem. Dem make juju with dia silva and gold; juju wey dey kause wahala for dem.
HOS 8:5 I hate di gold melu wey Samaria pipol dey woship. I dey vex well-well for dem. Na wen dem go stop to woship juju?
HOS 8:6 Na una Israel pipol karve di juju by unasef. Di juju nor bi god! Di gold melu wey una dey woship for Samaria, go skata to pieces!
HOS 8:7 Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.
HOS 8:8 Israel pipol bi like oda nashons naw and dem dey yuzles like pot wey break.
HOS 8:9 Israel pipol sturbon like wiked donkey and dem don waka go dia own way. Dem don go meet Assyria pipol make e help dem kon pay oda nashons to protet dem.
HOS 8:10 But naw, I go gada dem togeda kon ponish dem. E nor go tey before dem go kry with pain wen Assyria king go kom opress dem.
HOS 8:11 Di more Israel pipol dey build altar to remove sin, di more dem dey get many place where dem go for dey sin well-well!
HOS 8:12 I rite many-many laws for di pipol, but dem dey rijet dem, bikos dem won follow strenj and yeye god.
HOS 8:13 Dem dey offa sakrifice give mi kon chop di sakrifice meat. But mi wey bi God nor dey happy with dem and naw, I go remember dia sin kon ponish dem. I go send dem go back to Egypt!
HOS 8:14 Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”
HOS 9:1 “Israel pipol, make una stop to celebrate una festival like doz wey nor know God. Una don turn from una God and nor dey faithful to am again. Una don sell unasef give juju like ashawo wey dey di land and una love wetin una tink sey love una.
HOS 9:2 But very soon, una nor go get enough korn to chop and olive oil and wine nor go dey again.
HOS 9:3 Israel pipol nor go stay for God land again, but dem go-go back to Egypt, den for Assyria, dem go chop food wey dem dey forbid.
HOS 9:4 Dem nor go fit offa wine ofrin or sakrifice give God for der. Oga God nor go asept any of una sakrifice bikos e go bi like food wey dem offa give dead body and doz wey chop am, nor go dey klean. Una go only dey chop am bikos of honga, but make una nor bring any one kom God temple.
HOS 9:5 So na wetin una go do wen festival time rish? How una go take do Oga God festival?
HOS 9:6 Even if dem eskape distroshon for Assyria, Egypt sojas go kill dem and Memfis pipol go beri dem. Grass and shuku-shuku go grow kover all di place where dia house and silva dey.
HOS 9:7 Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.
HOS 9:8 Na di profet dey wosh ova Israel for God. But anywhere wey e go, una dey won katch am like bird. Even for God house, all di pipol hate am.
HOS 9:9 Just as dem sin for Gibeah, na so too dia sin and wikedness dey bad rish. God go remember dia sin kon ponish dem.”
HOS 9:10 God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.
HOS 9:11 Efraim greatness go fly komot like bird and dem nor go born shidren. Dia wimen nor go get belle at-all.
HOS 9:12 Even if dem born, I go kill di pikin. Bad-bad tins go happen to dis pipol wen I don leave dem.”
HOS 9:13 Na for my present Israel pipol grow until dem kom fine like Tyre. But naw, only dem go use dia hand bring dia shidren out kon kill dem.
HOS 9:14 Oga God, na wetin I won sey make Yu do to dis pipol? Make dia wimen nor get belle at-all and nor let dem train dia own shidren!
HOS 9:15 So God sey, “All di bad tins wey dem dey do, na Gilgal dem from start am and na from der I start to hate dem kom. I go drive dem komot from my land, bikos of di evil wey dem do. I nor go love dem again. Yes! Even dia leaders don go against mi.
HOS 9:16 Efraim pipol go bi like plant wey en rut don dry and nor dey bear fruit again. Dem nor go get shidren and even if dem get, I go kill di ones wey dem like pass.”
HOS 9:17 God wey I dey serve go rijet en pipol, bikos dem nor gri listin to am and dem go dey waka up-and-down for difren kountry.
HOS 10:1 Israel pipol bi like grape vine wey grape full. But di more dem dey prosper, di more dem dey build juju altars. Di more good-good tins dey happen for di town, di more dem dey make and woship juju.
HOS 10:2 Na wikedness full di pipol heart, so dem must sofa for dia sin. God go distroy dia altar kon skata all dia holy pilas.
HOS 10:3 Dis pipol go soon start to sey, “Wi nor get king, bikos wi nor dey fear God. But wetin king fit do for us sef?”
HOS 10:4 Na empty words dem dey tok kon dey give lie-lie promise and naw, just as dem turn field wey betta plant suppose grow to where poizin grass full, na so too dem don turn betta judgement to bad one.
HOS 10:5 So, Samaria pipol go mourn for di juju wey Bet-Aven pipol. Dem go kry, bikos dem go take di juju from dem kon karry am go anoda land.
HOS 10:6 Dem go give di juju as gift to Assyria king. Dem go disgrace and make Israel pipol shame, bikos dem go follow juju.
HOS 10:7 Dem go karry dia king go like wood wey wota float go.
HOS 10:8 Dem go skata di juju house on-top di hill for Aven where Israel pipol for dey go woship am. Shuku-shuku and grass go grow kover dia altars. Di pipol go shaut koll di mountins sey, “Make yu kom hide us!” Dem go tell di hill, “Make yu kom kover us!”
HOS 10:9 Oga God sey, “Israel pipol, na since una dey Gibeah una dey sin kom rish naw and una nor dey progress at-all. Una nor si as dem kill Gibeah wiked pipol for war?
HOS 10:10 So, I go attack and ponish dis pipol wey dey sin. Difren kountry go gada against dem and I go ponish dem, bikos of dia sins.
HOS 10:11 Israel pipol bi like yong melu wey dem train well before; dem dey ready to separate di korn from di grass. But I don make up my mind sey I go use rope tie dia fine neck kon make dem do hard work. I go make Judah and Israel pipol do strong-strong work.
HOS 10:12 I sey, ‘Make una plant raitiousness for unasef, den una go harvest love wey nor dey end. Make una klear new groun for unasef, bikos dis na di time to turn kom meet mi, so dat I go save una.’
HOS 10:13 But with evritin wey I tok, una plant wikedness kon harvest wetin una plant. Una don chop di fruit wey una lie-lie kause. Bikos una trust una shariot and di many sojas wey una get,
HOS 10:14 war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.
HOS 10:15 Bethel pipol, dat na wetin go happen to una, bikos of di bad-bad tins wey una don do. Wen dat day don kom, dem go distroy Israel king.
HOS 11:1 “Na since wen Israel bi small pikin I love am and I kon koll am komot from Egypt.
HOS 11:2 But di more I dey koll am, di more e dey waka far from mi kon dey do sakrifice and burn incense give juju.
HOS 11:3 Na mi tish Efraim how to waka. I karry my pipol for my hand, but dem nor know sey I kare for dem.
HOS 11:4 I draw dem near body with love and kindness. I remove dia heavy load from dia head kon bend down feed dem by mysef.
HOS 11:5 But dem nor gri kom back kon meet mi and bikos of dat, dem must go back to Egypt and Assyria pipol go rule dem by force.
HOS 11:6 War go kom dia towns kon break and skata dia gates. Enemies go distroy my pipol for where dem tink sey nor-tin go fit happen to dem.
HOS 11:7 Dem don gri sey dem nor go turn kom meet mi. Dem koll mi wey bi di Most High God, but I nor go raiz dem up at-all.
HOS 11:8 Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.
HOS 11:9 I nor go ponish una, bikos I dey vex; I nor go distroy Efraim again, bikos I bi God and I nor bi man. Mi wey dey holy, dey with una. I nor go vex kom meet una.
HOS 11:10 I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west.
HOS 11:11 Dem go rush kom from Egypt like bird and from Assyria like dove. I go bring dem kom back to dia town again.
HOS 11:12 Israel pipol surround mi with lie-lie; na wayo full Efraim, but Judah pipol still trust and dey faithful to God wey dey holy.
HOS 12:1 Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.
HOS 12:2 Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.
HOS 12:3 Even for dia mama belle, Jakob struggol with en broda Esau and wen Jakob grow, e still struggol with God.
HOS 12:4 E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.
HOS 12:5 Oga God wey dey mighty; na God bi en name forever.
HOS 12:6 So, make una turn kom meet una God. Make una show love; dey judge well and dey patient as una dey wait for God.
HOS 12:7 But Israel pipol nor dey tok true; dem bi like Kanaan pipol wey dey shit and play dia customers wayo.
HOS 12:8 Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”
HOS 12:9 “But na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt; I go make una stay for tent again, just as e bi wen una dey do Shelta Feast.
HOS 12:10 I send my profets kon warn una with many vishon and parabol.
HOS 12:11 But Jabesh-Gilead pipol nor mean anytin bikos dem dey woship juju. And dem dey sakrifice animals for Gilgal; dia altars bi like stones wey dem gada togeda for field wey dem klear.
HOS 12:12 Jakob run go Aram land. For der, e kare for sheep, to take pay for en wife.
HOS 12:13 Na profet God take save Israel pipol from Egypt where dem bi slave and na profet e take guide dem.
HOS 12:14 But Efraim pipol make God vex well-well; so E go ponish dem bikos of di innocent pipol wey dem kill kon pay dem back for dia sin.”
HOS 13:1 Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.
HOS 13:2 Dem still dey sin and woship juju wey dem make kon design am with silva. Dem dey sey, “Make una kom sakrifice and kiss dis juju!”
HOS 13:3 So just as dew dey vanish for morning, na so dis pipol go disappear too. Dem go-go like leaf wey breeze blow or smoke wey dey fade.
HOS 13:4 God sey, “Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt. Una nor get anoda God apart from mi. Na mi dey save una.
HOS 13:5 Wen una dey dry land wey nor get anytin, na mi take kare of una.
HOS 13:6 But naw wen una enter betta land, una don dey okay; dey karry body up kon forget mi.
HOS 13:7 So, I go attack una like lion. I go hide for bush dey wait una like leopard.
HOS 13:8 I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wiked animals dey distroy tins, na so too I go distroy una.
HOS 13:9 Israel pipol, mi wey bi una only helpa go soon distroy una.
HOS 13:10 Una dey ask for king and leaders; how dem won take save una naw?
HOS 13:11 Na mi vex give una kings and I still vex take dem komot.
HOS 13:12 I don gada Efraim pipol sin kon keep am dey wait di time wen I go ponish dem.
HOS 13:13 Israel get shance to live, but dem too dey foolish to si am; just like pikin wey dem just one born, wey nor gri kom out from en mama belle.
HOS 13:14 I nor go save dis pipol from grave or save dem from deat pawa. So deat, make yu bring all yor wahala kom! Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom, bikos I nor go pity for dis pipol again.
HOS 13:15 Even doh Israel dey grow like betta grass, I go send hot desert breeze from east kom dry dia rivers and well. E go distroy evritin wey dem value.
HOS 13:16 I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”
HOS 14:1 Israel pipol, make una turn back kom meet di Oga una God, bikos una sin don make una fall.
HOS 14:2 Make una turn kom meet God and pray to am sey: “Make Yu forgive us awa sin kon asept awa prayers, so dat wi go praiz Yu.
HOS 14:3 Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”
HOS 14:4 So God ansa, “I go bring my pipol kom back to mi. I go love dem with all my heart and I nor go vex for dem again.
HOS 14:5 I go bi like dew to Israel pipol. Dem go shine like lily flower kon strong for groun like Lebanon tree.
HOS 14:6 Dia branches go spread kom out like fine olive tree. Dem go get good smell like Lebanon trees.
HOS 14:7 I go protet dem again. Dem go prosper like betta korn wey dem plant kon fine like grape gardin. Pipol go know dem like di way dem know Lebanon wine.
HOS 14:8 Efraim pipol nor go get anytin to do with juju again. I go ansa dia prayers kon kare for dem. I go give dem house like betta green fig tree and na mi go bless dem.”
HOS 14:9 Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
JOE 1:1 Dis na di message wey God give Joel wey bi Petuel pikin.
JOE 1:2 Una wey bi leaders, make una listin! Evribody wey dey stay dis land, make una listin well-well. Anytin like dis don ever happen for una time or for una grand-grand papa dem time?
JOE 1:3 Make una tell una shidren about am and make dem tell dia own shidren and dia shidren go tell dia shidren-shidren too.
JOE 1:4 Ants don chop all wetin wi plant and as one set dey go, anoda set dey kom, until dem go chop and distroy evritin wey remain.
JOE 1:5 Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
JOE 1:6 Many sojas from one strong kountry don kom attack awa land. Nobody fit kount dem and dia tit strong and sharp like lion own.
JOE 1:7 Dem don distroy awa grapevines and skata awa fig trees. Dem tear di trees open, until di white part for di wood kon dey show.
JOE 1:8 Make una kry like virgin wey dey mourn for di man wey e suppose marry.
JOE 1:9 Di priest dem dey mourn, bikos wine and korn ofrin nor dey to offa for di temple again.
JOE 1:10 Di farm don empty; di groun dey mourn, bikos dem don distroy all di korn. All di grapes and di olive trees don dry.
JOE 1:11 Una wey bi farmer and doz wey dey kare for di vineyards, make una kry, bikos of una rice and sweet korn. Yes! All wetin wi plant don skata.
JOE 1:12 Di grape vine and fig trees don dry and all di oda trees don die too. True-true, di pipol nor get joy again.
JOE 1:13 Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!
JOE 1:14 Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!
JOE 1:15 God day don near, di day wen di Almighty go distroy evriwhere. Dat day go bad well-well!
JOE 1:16 Wi just dey look as dem dey distroy awa food and wi nor fit do anytin. Nobody dey happy for God temple again.
JOE 1:17 Di seed dem die for dry groun. No korn to keep, so awa store don empty and skata.
JOE 1:18 All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.
JOE 1:19 Oga God, na Yu I dey kry to, so make Yu kom help us! Di grass and trees don dry rish groun, bikos fire don burn dem.
JOE 1:20 Even wild animals dey kry, bikos no wota to drink for anywhere and fire don burn all di grass finish.
JOE 2:1 Make yu blow di trumpet, so dat dem go hear am for Zion wey bi God holy hill. Make evribody fear well-well, bikos God day dey kom.
JOE 2:2 For dat day, darkness go kover di land and kloud go full evriwhere! Strong-strong sojas go kom and dem go bi like darkness wey spread kover di mountins. Dis kind tin neva happen before and sometin like dis nor go ever happen again.
JOE 2:3 Dem go distroy evritin wey dem si like sey na fire burn dem. For dia front, di land bi like Eden Gardin, but wen dem don pass, e go bi like desert for dia back. Dem go distroy evritin finish.
JOE 2:4 Dem resemble horse and dem dey run fast-fast like war horse.
JOE 2:5 Dem go dey make nois like war horse wey dey run on-top mountin and dia nois bi like dry grass wey fire dey burn. Dem bi like strong sojas wey ready to go fight.
JOE 2:6 Evribody dey fear and kry as dem si dem dey kom.
JOE 2:7 Dem dey attack pipol like wariors kon klimb pass wall like sojas. All of dem dey mash strait dey kom; dem nor dey bend or waka anyhow
JOE 2:8 or enter each oda front. Dem waka pass many trap and nor-tin fit stop dem.
JOE 2:9 Dem rush enter di town; dey run up-and-down for di wall. Dem klimb kon enter all di house thru window like sey dem bi tif.
JOE 2:10 Di eart and sky dey shake as dem dey kom. Di sun and di moon kon dark wons and stars nor shine again.
JOE 2:11 God vois bi like tonda as E dey lead en sojas wey nobody fit kount. And doz wey dey obey en kommand, many and strong well-well. Di day wey God choose go great well-well, so na who go fit survive am?
JOE 2:12 Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.
JOE 2:13 Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.
JOE 2:14 Who know weda di Oga una God go shange en mind kon bless una with many-many food. Den una go offa korn and wine gi-am again.
JOE 2:15 Make una blow di trumpet for Mount Zion; koll di pipol gada kon orda sey make dem fast!
JOE 2:16 Make una gada di pipol; prepare dem for di holy meetin; bring di old pipol, den gada all di shidren too. Even pipol wey just marry must kom out from dia bedroom.
JOE 2:17 Make di priest wey dey serve God for di altar, stand and kry for di temple gate kon sey, “My Oga God, make Yu sorry for yor pipol. Nor allow oda nashons hate, laf and ask us sey, ‘Where una God der?’ ”
JOE 2:18 Den God go sorry for di land kon pity for en pipol.
JOE 2:19 God go ansa: “Naw, I go give una korn, wine, olive oil and una go chop beleful. Oda nashons nor go laf una again.
JOE 2:20 I go remove di strong sojas wey kom from nort kon drive dem enter desert. I go drive dia leaders enter Dead Sea and doz sojas wey dey lead dem, I go drive dem enter Mediterranean Sea. Dia dead body go smell well-well. I go distroy dem, bikos of all wetin dem do una.
JOE 2:21 So, make di land nor fear, instead make una happy well-well, bikos of wetin God don do for una.
JOE 2:22 Make una animals nor fear. Di field go get grass; di trees go bear dia fruit and fig and grapes go plenty well-well again.
JOE 2:23 Zion pipol, make una happy, bikos of wetin Oga God do for una. Bikos E don give una rain. E send both di early and late rain kom meet una, just as E dey do before.
JOE 2:24 Korn go full una house; wine and olive oil go full where dem for dey press am.
JOE 2:25 Evry of una tin wey lokusts chop and distroy for doz years, I go give dem back to una, bikos na mi send doz lokust against una.
JOE 2:26 Una go get plenty food to chop kon beleful. Una go praiz di Oga una God wey don do many wonderful tins for una and nobody go laf my pipol again.
JOE 2:27 Den, una Israel pipol go know sey I dey with una and una go sey, ‘Na Yu bi awa God and nobody bi like Yu.’ Nobody go ever laf my pipol again.”
JOE 2:28 Afta all dis tins, I go put my spirit for una body. Una shidren go prish my message; di old pipol among una go dey dream dreams, while di yong ones go dey si vishon.
JOE 2:29 For dat time, I go pour my spirit for una savants body; both man and woman.
JOE 2:30 Make I warn una about dat day, bikos blood, fire and smoke go full evriwhere, both for di eart and for di sky.
JOE 2:31 Di sun go turn to darkness and di moon go turn to blood. All dis tins go happen before di great day wey God don choose, go kom.
JOE 2:32 And evribody wey koll God name, go dey save; bikos on-top Mount Zion, God go diliver pipol just as E tok. Dem go survive with doz wey God don koll.
JOE 3:1 “For dat time, wen I don make Judah and Jerusalem prosper again,
JOE 3:2 I go gada and judge di pipol for Jehoshafat Valley, bikos of wetin dem do my pipol. Dem skata Israel pipol for evriwhere kon divide dia land.
JOE 3:3 Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.
JOE 3:4 Tyre, Sidon and Filistia pipol, wetin una dey do mi? Una dey try to pay mi back for wetin I do? If na so, den I go kwik-kwik attack una!
JOE 3:5 Una take my gold and silva kon karry all my betta-betta tins go una temple.
JOE 3:6 Una sell Judah and Jerusalem pipol give Greek pipol so dat dem go karry dem go far kountry.
JOE 3:7 But I go bring dem kom back from where una sell dem go. Na wetin una do dem, na-im I go do una too.
JOE 3:8 I go make dem sell una shidren give Judah pipol; dem go sell dem go Sabeans land wey far well-well.
JOE 3:9 So make una tell pipol for difren kountry sey: “Make una ready for war and koll all una strong-strong men, den gada dem go fight!
JOE 3:10 Make una do una swod well kon sharpen una spears. Even pipol wey weak or nor get pawa, must fight.
JOE 3:11 All di nashons wey dey round una, make dem join una as una gada for di valley.” So, my Oga God, make Yu send yor sojas kom!
JOE 3:12 Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley. Na for der mi wey bi God go sidan judge all of dem.
JOE 3:13 Dem wiked well-well and just as dem dey kut korn for harvest time, na so too I go kut dem trowey kon mash dem, just as dem dey mash grapes until di wine kom out finish.
JOE 3:14 Plenty-plenty pipol dey Judgement Valley. For der, God day go soon kom.
JOE 3:15 Di sun and moon don dark and di stars nor dey shine again.
JOE 3:16 God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.
JOE 3:17 “Den, Israel pipol, una go know sey na mi bi di Oga una God. I dey stay for Zion wey bi my holy hill. Jerusalem go bi holy town and strenjas nor go fit win am again.
JOE 3:18 For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.
JOE 3:19 But Egypt land go bi desert and na only dirty go dey Edom land, bikos dem attack Judah kon kill innocent pipol.
JOE 3:20 But pipol go full Judah land forever and Jerusalem land go dey from one generashon go rish anoda one.
JOE 3:21 My pipol wey I neva forgive before, I go forgive dem and mi wey bi Oga God go stay for Jerusalem with my pipol.”
AMO 1:1 Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel.
AMO 1:2 Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”
AMO 1:3 God sey, “Damaskus pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem flog Gilead pipol with stik wey get iron tit.
AMO 1:4 I go send fire kon burn di palis wey King Hazael build. I go burn King Ben-Hadad strong-strong buildings rish groun.
AMO 1:5 I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.”
AMO 1:6 God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.
AMO 1:7 So I go skata Gaza town with fire kon burn all di strong-strong buildings wey dem hide put.
AMO 1:8 I go kill all di rulers for Ashdod and Ashkelon town. I go ponish Ekron town and Filistia pipol wey remain, go die.”
AMO 1:9 God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.
AMO 1:10 So, I go skata di town kon burn all dia strong-strong building for der.”
AMO 1:11 God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.
AMO 1:12 So, I go distroy Teman town kon burn Bozrah strong-strong buildings.”
AMO 1:13 God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.
AMO 1:14 So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.
AMO 1:15 Dem go karry dia king and en ofisas as slave go anoda land.”
AMO 2:1 Dis na wetin Oga God tok, “Moab pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem nor respet Edom kings wey don die since; instead dem burn dia bones to ashes.
AMO 2:2 So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.
AMO 2:3 I go kill all dia rulers and leaders.”
AMO 2:4 God sey, “Bikos Judah pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem hate wetin I tish dem and nor gri obey my kommand. Di same lie-lie gods wey dia grand-grand papa dem serve, don deceive dem too.
AMO 2:5 So I go distroy Judah kon burn all di strong-strong buildings wey dey Jerusalem rish groun.”
AMO 2:6 God sey, “Bikos Israel pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem sell innocent pipol bikos of silva kon sell poor pipol, bikos of ordinary shoe.
AMO 2:7 Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy.
AMO 2:8 For where dem for dey woship, dem dey kover diasef with klot wey dem kollect from poor pipol as payment for debts. For inside God temple, dem dey drink wine wey dem kollect from doz wey dey whole dem money.
AMO 2:9 I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.
AMO 2:10 Na mi still bring una kom out from Egypt; lead una pass desert for forty years, den give una Amor pipol land.
AMO 2:11 I make some of una pikin profets and some of una yong men, I make dem Nazirites. So God kon ask dem, ‘Israel pipol, nor bi trut I dey tok?’
AMO 2:12 But una make di Nazirite drink wine kon sey make di profets nor prish my message.
AMO 2:13 But naw, I go distroy una finish and una go kry with pain like truck wey dem ova-load with korn.
AMO 2:14 Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.
AMO 2:15 Men wey dey karry bow nor go fit defend demsef; doz wey dey run fast nor go fit eskape and men wey dey on-top horse nor go fit save demsef.
AMO 2:16 For dat day, even di sojas wey strong well-well go drop all di tins wey e take dey fight kon run.”
AMO 3:1 Israel and Judah pipol wey God take komot from Egypt, make una listin to wetin E tok against una.
AMO 3:2 “Out of all di families for di eart, na only una I know and kare for and bikos of dis, I go ponish una for all una sins.”
AMO 3:3 Two pipol go fit waka togeda, if dem nor gri?
AMO 3:4 Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?
AMO 3:5 Trap dey fit katch bird, if dem nor use food take set am? Abi trap dey komot from where dem set am put if e nor katch animal?
AMO 3:6 Pipol nor dey fear, if dem blow war trumpet for di town? Abi wahala dey just happen for town, wen God nor allow am?
AMO 3:7 Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.
AMO 3:8 So na who nor dey fear if lion dey shaut? God wey dey mighty don tok, na who nor go tok about am?
AMO 3:9 Go tell di pipol wey dey stay for Egypt and Ashdod palis sey, “Make una gada round di hills for Samaria! Make una si di wahala wey dey happen for di town and di bad-bad tins wey dem dey do.”
AMO 3:10 God sey, “Propaty wey dis pipol use wahala and wayo get, na-im dem pak full dia house and dem nor even dey tok trut or do wetin dey rite.”
AMO 3:11 So God sey, “Enemies go surround dia land, distroy dia pawas kon tif dia propaty.”
AMO 3:12 Oga God sey, “Na only few pipol for Samaria go eskape with dia life and with small piece for dia bed and chair. E go bi like wen shepad save two leg and some part of en sheep ear from lion mout.”
AMO 3:13 God wey get pawa sey, “Make yu listin and warn Jakob shidren-shidren sey,
AMO 3:14 ‘For di day wen I go ponish Israel pipol for dia sin, I go distroy Bethel altars. I go break and skata evry altar for der too.
AMO 3:15 I go distroy all di house wey rish pipol build bikos of rain and dry sizin. All di house wey dem use ivory stone take dekorate, go fall skata and di big-big house go skata finish.’ ”
AMO 4:1 Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”
AMO 4:2 Bikos God dey holy, E don promise sey, “Di day dey kom wen dem go karry all of una go for inside basket like fish wey hook katch.
AMO 4:3 Dem go drag una kom out from di small hole wey dey una wall kon karry una go Harmon land.”
AMO 4:4 God sey, “Afta una, Israel pipol don go Bethel go sin for di holy place and woship juju for Gilgal, una go kon sakrifice animals for morning, den for evry three days, una go bring one out of evry ten tins wey una get kom.
AMO 4:5 Bread wey dem make with yist, una dey bring am as ofrin to take tank mi and dey karry body up bikos of di oda ofrins wey una give. True-true, dis na di kind tin wey una like to do.”
AMO 4:6 God sey, “Na mi make hongry dey una town, but una nor still gri turn kom meet mi.
AMO 4:7 Na mi stop di rain to fall for una land three monts before una go harvest wetin una plant. Sometaims, I dey let rain fall for one town or field and di oda town go dry well-well bikos I nor allow rain fall for der.
AMO 4:8 So pipol dey stagga from one town go anoda town go look for wota wey dem go drink, but dem nor si enough wota drink and with all dis tins, una nor still gri turn from sin kom meet mi.”
AMO 4:9 “I send hot breeze kon dry all wetin una plant. Ant chop all wetin una plant for una vineyard, even una fig and olive tree too. Yet una nor still gri turn kom meet mi.”
AMO 4:10 “I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.”
AMO 4:11 “I distroy some of una town, just as I distroy Sodom and Gomorrah. And una wey remain bi like stik wey dey burn before dem komot am from fire. With all dis one, una still nor gri turn kom meet mi.”
AMO 4:12 Naw, Israel pipol, mi God go ponish una, so make una dey ready to face my judgement!
AMO 4:13 “Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill.
AMO 5:1 Israel pipol, make una listin to dis sorrowful song wey I dey sing give una:
AMO 5:2 “Israel town wey ‘neva sin wons’ don fall and e nor go fit raiz again! E just dey groun like dat and nobody gri help am.”
AMO 5:3 God wey get pawa sey, “One town for Israel send 1,000 sojas go fight, but na only hundred pipol kom back; anoda town send hundred, but na ten kom back.”
AMO 5:4 God tell Israel, “Make una kom back kom meet mi and una nor go die.
AMO 5:5 Make una nor go Beersheba go woship. Make una nor find mi go Bethel, bikos Bethel nor mean anytin again. Make una nor go Gilgal, bikos dem go soon karry en pipol as slave go anoda land and Bethel go turn empty land.”
AMO 5:6 So, make una go meet God and una nor go die. If una nor go meet am, E go kom on-top una like fire. Di fire go burn Bethel pipol and nobody go fit kwensh am or save una.
AMO 5:7 Israel pipol dey turn bitter judgement to bad one, dem dey trowey wetin dey good and korrect for groun!
AMO 5:8 But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.
AMO 5:9 E distroy strong pipol and di pawa wey dem feel sey dem get.
AMO 5:10 Una nor like anybody wey dey judge well or tok trut for kourt.
AMO 5:11 So, since una dey opress and tif from poor pipol, una nor go stay for di fine house wey una build or drink wine from di fine vine wey una plant.
AMO 5:12 Una sin and all di bad-bad tins wey una do, I know as dem bad rish. Una ponish good pipol; dey take bribe and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.
AMO 5:13 So, to keep kwayet for dis kind evil time, naim bi di best tin to do!
AMO 5:14 Make to do good dey sweet una, nor bi wetin dey bad, so dat una go get life. Den Oga God wey get pawa go really dey with una, just as una tok.
AMO 5:15 Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.
AMO 5:16 So God wey get pawa sey, “For di town, pipol go dey kry and mourn for evriwhere. Dem go sey make farmers kry for dia land, den dem go pay pipol wey go kom mourn with dem.
AMO 5:17 Na so-so kry pipol go dey kry for evry vineyards. All dis go happen, bikos I dey kom ponish una.”
AMO 5:18 E go bad well-well for una wey dey wait for God day! Wetin make una dey wait for dat day to kom? Instead make di day bring lite, na darkness go kom.
AMO 5:19 E go bi like pesin wey run hide bikos of lion, but where e hide put or run enter, na tiga e go meet for der! Or like pesin wey run go hide for house, but as e put en hand for wall, snake kon bite am!
AMO 5:20 Instead make God day bring lite, na darkness go follow am kom. Dat day nor go good at-all, bikos e go dark well-well.
AMO 5:21 God sey, “I hate di juju feast wey una dey do; I nor fit bear dem!
AMO 5:22 Wen una bring korn and burnt ofrin kom give mi, I nor go asept am; I nor go asept di animals wey una kill kon offa give mi as ofrin.
AMO 5:23 Make una stop to make nois sey una dey sing; I nor won listin to una harp wey una dey play.
AMO 5:24 Instead, make korrect judgement dey rush like river, while raitiousness go bi like river wey nor dey dry.
AMO 5:25 Israel pipol, I nor ask una for sakrifice and ofrin for doz forty years wey I lead una pass desert.
AMO 5:26 But naw, bikos una don woship Sikkut image, wey bi una king god and Kiyyun wey bi una star god, una go karry dem
AMO 5:27 follow body wen I take una as slaves go anoda land wey far pass Damaskus.”
AMO 6:1 E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion and una wey feel sey una dey save for Samaria. Una tink sey na una strong pass, bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.
AMO 6:2 Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
AMO 6:3 Una nor won gri sey wahala dey kom and wetin una dey do, go make am kwik kom.
AMO 6:4 E go bad well-well for una wey dey relax for una big fine chair kon dey chop betta meat!
AMO 6:5 Una dey sing difren songs and dey play harp, just as David bin dey do.
AMO 6:6 Una dey drink wine from di basin wey una dey use for sakrifice and dey spray betta perfume for body, but una nor kare about Israel land wey don skata.
AMO 6:7 So, na una dem go first katch as slave. And all di food, drink and party wey una dey do, go end.
AMO 6:8 Oga God wey get pawa don warn una well-well sey, “I hate as Israel pipol proud rish; I hate di strong and big-big house wey dem get. I go give dia main town and evritin wey dey inside, to dia enemies.
AMO 6:9 If na ten men remain for one family, all of dem go die finish.
AMO 6:10 Wen dia rilashons; di pipol wey go burn di dead body go kom karry di body komot from di house, dem go ask di pesin wey dey di house sey, ‘E get any oda pesin wey dey here with yu?’ Di pesin go ansa, ‘No!’ Den di rilashons go sey, ‘Kwayet! Make yu nor just menshon God name.’ ”
AMO 6:11 True-true, make una si! Wen God kommand, both big and small house go skata to pieces.
AMO 6:12 Horse fit run well on-top rock? Abi human being fit ride horse on-top wota? Yet, una don turn bitter judgement to poizin and good to bad.
AMO 6:13 Una dey boast sey una seize Lo-Debar town and una sey, “Nor bi wi win and katch Karnaim town with awa own pawa?”
AMO 6:14 Oga God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una si! I go send sojas kom distroy una kountry and dem go opress una from Lebo-Hamat for nort go rish Arabah River wey dey sout.”
AMO 7:1 Dis na wetin Oga God show mi for vishon: I si as E dey prepare many lokust to kom attack all di plant for di land. Dis tin happen afta dem don harvest di king share and di remainin plant dey grow kom out.
AMO 7:2 For my vishon, I si di lokust dey chop all di plant wey dey grow for di land, so I sey, “God wey get pawa, I beg, make Yu forgive us; wi nor go survive dis wahala bikos wi nor plenty and wi weak well-well.”
AMO 7:3 So God shange en mind kon sey, “Wetin yu si, nor go happen again.”
AMO 7:4 God kon show mi anoda strong vishon. For dis vishon, I si as E dey ready to ponish en pipol with fire. Di fire burn di big sea, den e kon start to burn di land.
AMO 7:5 Den I sey, “Oga God, make Yu stop dis fire! How wi go take survive dis fire, bikos wi nor plenty and wi weak well-well.”
AMO 7:6 So God shange en mind again kon sey, “Dis one nor go happen too.”
AMO 7:7 I kon si anoda vishon. For dis vishon, I si God stand near one wall wey dem measure well before dem build am and di ruler dey en hand.
AMO 7:8 E kon ask mi, “Amos, wetin yu dey si?” I ansa, “Na ruler.” Den E sey, “I go test my pipol with dis ruler. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
AMO 7:9 I go distroy all di place where Isaak shidren-shidren for dey woship juju and skata all dia holy place for Israel. Jeroboam shidren-shidren nor go bi king again.”
AMO 7:10 Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.
AMO 7:11 Bikos dis na wetin Amos tok: ‘Jeroboam go die for war and dem go karry Israel pipol from dia land go anoda land as slave.’ ”
AMO 7:12 So Amazaya sey make dem tell Amos, “Komot for here, yu wey dey profesai! Yor tok don too mush! Make yu go Judah town and kontinue to prish for der, so dat dem go pay yu.
AMO 7:13 Nor profesai for Bethel again, bikos na here di king for dey woship for di main temple.”
AMO 7:14 Amos ansa, “I nor bi profet before and I nor bi profet pikin. Na shepad I bi and I dey kare for fig trees.
AMO 7:15 But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.
AMO 7:16 So naw, make yu listin to wetin God tok. Yu sey make I stop to profesai and warn Israel pipol; make I nor prish against Isaak family, abi?
AMO 7:17 Naw, Amazaya, God dey tell yu sey, “ ‘Yor wife go turn ashawo for di town and dem go kill yor shidren for war. Dem go divide yor land kon gi-am to oda pipol and yu yorsef go die for yor enemies kountry. Dem go must take Israel pipol from dia own land kon karry dem go anoda land as slave.’ ”
AMO 8:1 Dis na wetin Oga God show bi: For di vishon, I si one basket wey fruit full.
AMO 8:2 God kon ask mi, “Amos, na wetin yu dey si?” I ansa, “Na basket wey fruit full.” Den God tell mi, “Di end don kom for my pipol, Israel. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
AMO 8:3 “For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
AMO 8:4 Make una listin, una wey dey opress and distroy poor pipol wey dey di town.
AMO 8:5 Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.
AMO 8:6 Wi go buy poor pipol with money and doz wey nor get anytin, wi go buy dem with sandals kon even sell awa korn kanda too.”
AMO 8:7 Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.
AMO 8:8 So di eart go shake and evribody for di land, go sofa. Di whole kountry go shake; dem go raiz-up kon fall like Nile River for Egypt.
AMO 8:9 For dat day, I go make di sun vanish for aftanoon and darkness go dey di eart for day time.”
AMO 8:10 “I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.
AMO 8:11 Di time dey kom wen I go send honga kom di land. Pipol go dey hongry, but nor bi for food. Dem go dey thirsty, but nor bi bikos of wota; instead dem go dey hongry to hear God message.”
AMO 8:12 “Pipol go dey waka up-and-down from Dead Sea go Mediterranean Sea kon from nort go east. Dem go dey find God message for evriwhere, but dem nor go si am.
AMO 8:13 For dat day, even strong men and wimen go dey hongry to hear God word.
AMO 8:14 And doz wey swear with dat yuzles Samaria juju or with Dan juju name and vow with Beersheba juju, go fall for groun and dem nor go raiz-up again.”
AMO 9:1 I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake. “Break dem make e fall for di pipol head. I go kill di remainin pipol for war and nobody go fit eskape.
AMO 9:2 Even if dem dig and hide for inside grave, I go still katch dem. And if dem klimb go heaven, I go bring dem kom down.
AMO 9:3 If dem hide on-top Mount Karmel, I go find and katch dem. If dem hide for bottom sea, I go kommand di wiked animals for sea make e bite dem die.
AMO 9:4 If dia enemies karry dem go as slave, I go orda make dem kill dem. I don ready to distroy dem and nor bi to help dem.”
AMO 9:5 Oga God wey get pawa, tosh di eart and e shake; evribody wey dey stay der dey mourn and di whole world dey raiz and fall like Nile River.
AMO 9:6 God build en house for di heavens and put di foundashon for dis eart. E draw di wota wey dey di sea kon pour am for di eart. En name na God!
AMO 9:7 God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.
AMO 9:8 Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.
AMO 9:9 I go kommand make dem shake Israel pipol just as dem dey shake korn wey dey tray. I go shake dem with di oda kountries, so dat di yuzles ones among dem go fall komot.
AMO 9:10 Doz wey dey sin among my pipol, dem go kill dem for war; pipol wey bin sey, ‘God nor go allow anytin bad happen to us.’ ”
AMO 9:11 God sey, “For dat day, I go ribuild David kingdom wey fall. I go ripair en fence kon build am back. I go build am again kon make am bi as e bi before.
AMO 9:12 Den Israel pipol go take all wetin remain for Edom land and all di nashons wey bi my own.”
AMO 9:13 God sey, “Di day dey kom wen korn go kwik grow even before harvest time rish and grape go grow kon ripe before dem suppose make wine. Sweet wine go dey rush kom out from di mountins and wine go dey flow for di hills.
AMO 9:14 I go bring my pipol kom back to dia land. Dem go ribuild dia towns wey skata kon stay der again; dem go plant vine kon drink di wine; dem go plant food for dia farm kon chop wetin dem plant.
AMO 9:15 I go plant my pipol for di land wey I give dem and nobody go fit rut dem komot again.”
OBA 1:1 Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: “Make una ready! Make una gada una sojas go fight Edom pipol!”
OBA 1:2 God tell Edom pipol, “Make una si! I go make una pipol weak and small well-well among all di nashons and pipol go hate una!
OBA 1:3 Una pride don deceive una, bikos una dey stay under rock where una dey save kon build big house on-top mountin. So una dey boast sey, ‘Na who go fit kon meet and attack us for der?’
OBA 1:4 But even if una fly like eagle or build una house among di stars, I go bring una kom down!”
OBA 1:5 “Wen tif kom rob yu for yor house for nite, dem go only tif wetin dem wont! Wen pipol go plok grape for dia vineyard, dem dey leave some for poor pipol! But una enemies go distroy una finish!
OBA 1:6 Dem go tif evritin wey dey for Edom land! Even di ones wey dem hide, dem go look for dem kon karry dem go!
OBA 1:7 Doz wey dey help una go turn against una. Dem go help una enemies porshu una komot from una land. Even doh dem dey plan to deceive and distroy una, dem go promise una peace. Una friends wey una trust pass, go set trap for una and una nor go even know.
OBA 1:8 For dat time, one singol wise pesin nor go dey for Edom land again. Bikos on-top Edom mountin, na der I go for distroy all doz wey get sense.”
OBA 1:9 “Doz strong sojas from Teman go fear and dem go kill evribody wey dey Edom mountin.”
OBA 1:10 “Bikos una use wikedness take kill una brodas for Israel, na shame and distroshon go follow una forever.
OBA 1:11 Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.
OBA 1:12 Una nor for dey happy wen dem karry una brodas as slaves go anoda land. Una nor for happy at-all wen Judah pipol dey sofa all dis tins. Una nor for tok anyhow for dat time wey Israel dey sofa.
OBA 1:13 Una nor for enter my pipol town wen dem dey face wahala kon tif dia propaty. Una nor for join dey tok anyhow wen my pipol dey sofa. Una nor for go tif my pipol propaty wen una si sey dem dey weak.
OBA 1:14 Una nor for stand for road dey kill doz una brodas wey dey try to eskape and una nor for katch dia pipol wey run as dem dey sofa.
OBA 1:15 “God Judgement dey kom for all di nashons! Just as una do to Israel, na so too dem go do una. All una evil works go fall for una own head.
OBA 1:16 Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.
OBA 1:17 “But doz wey eskape, go dey Mount Zion and e go dey holy again. Israel pipol go kom back kon take all dia propaty.
OBA 1:18 Jakob shidren-shidren go bi fire; Josef shidren-shidren go bi big smoke and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, dem go burn dem rish groun, bikos God don tok!
OBA 1:19 Den my pipol wey dey Negev go kollect Esau mountin. Doz wey dey stay near di hill for Judah go take di betta land wey dey Filistia, Efraim and Samaria. Den Benjamin pipol go take Gilead land.
OBA 1:20 Doz wey dem katch for Israel before, go kom back kon stay for Foenicia wotaside wey dey nort for Zarefat. Jerusalem pipol wey dem katch and karry go nort go kom back to dia house for Negev.
OBA 1:21 Doz wey dem save, go-go Mount Zion for Jerusalem kon rule all di mountins for Edom and Oga God go bi dia king!”
JON 1:1 One day, God tell Jonah wey bi Amittai pikin
JON 1:2 sey, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol about my judgement wey dey kom, bikos I don hear how di pipol for der wiked rish.”
JON 1:3 But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.
JON 1:4 But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces.
JON 1:5 Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep.
JON 1:6 Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”
JON 1:7 So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.
JON 1:8 Dem kon sey, “Make yu tell us! Na who make dis tins dey happen to us so? Na wish kind work yu dey do? Where yu from kom? Wetin bi yor kountry name and wish tribe yu bi?”
JON 1:9 Jonah ansa, “I bi Hibru pesin! I dey woship God; di Pesin wey make heaven, land and sea.”
JON 1:10 Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem.
JON 1:11 Bikos di breeze dey strong more-more, dem kon ask am, “Wetin wi go do yu naw make dis breeze for stop?”
JON 1:12 Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.”
JON 1:13 Instead, dem kon try to padol di ship go land back, but dem know fit, bikos di breeze strong well-well.
JON 1:14 So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”
JON 1:15 So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.
JON 1:16 Dis tin make di men fear God well-well, so dem offa sakrifice gi-am kon promise to serve am.
JON 1:17 So God send one big fish go swallow Jonah. Jonah dey di fish belle for three days and three nite.
JON 2:1 As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
JON 2:2 E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers.
JON 2:3 Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
JON 2:4 Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’
JON 2:5 Di wota kover and almost kill mi. Naw, I don sink enter di sea. Even di leaf dem wey dey di sea, don tie my head.
JON 2:6 I sink go under di mountins kon enter inside one place where I go bi prisona forever. But Yu, my God don take mi komot from di pit.
JON 2:7 Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.
JON 2:8 Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
JON 2:9 But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”
JON 2:10 Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.
JON 3:1 God kon tell Jonah for di sekond time,
JON 3:2 “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.”
JON 3:3 So Jonah obey God kon go Nineveh. (Nineveh na one big town and e go take three days to waka round am!)
JON 3:4 For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”
JON 3:5 Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem.
JON 3:6 Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes.
JON 3:7 E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin.
JON 3:8 Make evribody and dia animals wear sak kon pray well-well to God, den turn from dia sin go meet am.’
JON 3:9 May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”
JON 3:10 So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.
JON 4:1 Jonah nor happy bikos of wetin happen, so e kon dey vex.
JON 4:2 Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.
JON 4:3 So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
JON 4:4 Den Oga God kon ansa Jonah, “Na wish rite yu get to dey vex?”
JON 4:5 So Jonah kon go sidan for di east side for di town. E arrange one small place for der kon sidan dey wait to si wetin go happen to di town.
JON 4:6 Den God make one small plant grow kover Jonah, so dat e go fit rest well. So Jonah happy well-well, bikos of di plant.
JON 4:7 But di next day, God send one worm kom chop, distroy and kill di plant.
JON 4:8 Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
JON 4:9 But God tell am, “Wish rite yu get to dey vex bikos of di small plant?” Jonah ansa, “I get evry rite to vex till I die!”
JON 4:10 Den God tell am, “If yu dey vex sey I kill dis plant wey grow for only one nite kon die di next day; plant wey yu nor do anytin for or make grow,
JON 4:11 den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”
MIC 1:1 Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.
MIC 1:2 Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.
MIC 1:3 Si! God dey kom from en holy temple for heaven and E go skata all di juju altars for dis world.
MIC 1:4 Den di mountins go melt under en leg like kandol wey melt for fire kon rush enter di valley like wota wey dey rush kom from hill.
MIC 1:5 All dis tins go happen bikos of Israel pipol sturbones and sin. Una ask sey, “Na how wi take sturbon? Na who dem go blame for Israel pipol sturbones?” Nor bi Samaria wey bi di main town! “Where di place wey dem for dey serve juju?” Na Jerusalem dem dey!
MIC 1:6 “So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.
MIC 1:7 I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”
MIC 1:8 So, I go kry and mourn. I go just dey waka without klot and shoe. I go jump like jackal kon dey bihave like owl,
MIC 1:9 bikos my pipol sore too deep and e don even rish Judah too. Yes! E don rish Jerusalem gate.
MIC 1:10 Make una nor tell Gat pipol; make una nor let dem si una kry. Make una sidan for groun for Bet-Leafra kon pak san full una head.
MIC 1:11 Una, Shafir pipol, make una naked make shame katch una as dem dey karry una go as slave. Doz wey dey Zaanan nor go try am kom out from dia town. Wen una hear Bet-Ezel pipol dey kry, una go know sey dem nor even get who to help dem.
MIC 1:12 True-true Marot pipol dey wait for who go save dem, but God don bring wahala kom Jerusalem.
MIC 1:13 Lakish pipol, make una karry una horse and propaty run. Na una bi di first town for Judah wey join Israel pipol sin and una kon make Jerusalem pipol, sin too.
MIC 1:14 So, make una tell Moreshet-Gat town bye-bye. Na Akzib pipol deceive Israel king.
MIC 1:15 Maresha pipol, God go give una to una enemies wey go katch and skata una town. Den Israel leaders go-go hide for Adullam town.
MIC 1:16 Judah pipol, make una mourn and shave una hair, bikos dem go karry di shidren wey una love go as slave. Make una skrape una head like vulture own, bikos dem go karry una small-small shidren go work as slave for anoda land.
MIC 2:1 E go bad for doz wey nor dey sleep for nite, bikos of di bad tins wey dem dey tink and plan to do. For early morning, dem go rush go do wetin dem plan, bikos dem get pawa to do am.
MIC 2:2 Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, dem dey take am by force. Dem dey opress, shit and take pipol propaty.
MIC 2:3 But dis na wetin God dey tok, “I dey plan to distroy dis pipol and dem nor go fit eskape am. Trobol go follow dem, den dem nor go dey waka with pride again, bikos dat time go bad for dem.”
MIC 2:4 Wen dat time rish, pipol go use una as song take esplain how wahala bi and dem go use una wahala take dey sing sey: “Awa own don finish kpata-kpata! God distroy, take awa land from us kon gi-am to awa enemies.”
MIC 2:5 So wen di time rish to divide land for God pipol, dem nor go give una any part.
MIC 2:6 But di pipol tell mi, “Make yu nor tok like dat. Nor prish like dat, bikos dat kind wahala nor go ever happen to us!”
MIC 2:7 Israel pipol suppose tok like dis? God Spirit go get patient with dis kind karata? But if una go gri do wetin dey korrect, my word go konfort una.
MIC 2:8 But till naw, my pipol dey tok against mi like sey I bi dia enemy! Doz wey trust mi, una tif dia klot kon let dem look like pipol wey dey kom from war.
MIC 2:9 Una porshu wimen from dia house kon take evritin wey God give dia shidren.
MIC 2:10 So make una komot der and dis land nor dey save again, bikos una don use sin skata am finish!
MIC 2:11 If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!
MIC 2:12 “One day, I go gada Israel pipol; I go gada di ones wey remain, just as dem dey gada animals for farm. Yes! Pipol go plenty kon dey make nois for una land again!
MIC 2:13 Una leaders go free demsef and kon free una. From una enemies town, God go take una go back to una own land. Una kings go lead una again and God go guide una by ensef.”
MIC 3:1 I sey, “Una wey bi leaders for Israel, make una listin! Na una suppose know good from bad,
MIC 3:2 but na una even hate good tins kon love wiked tins. Una dey kill my pipol alive kon kut dia flesh from dia bone.
MIC 3:3 Yes! Una dey chop my pipol flesh, remove dia skin kon break dia bones. Una dey kut dem small-small like meat inside pot.
MIC 3:4 But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”
MIC 3:5 Dis na wetin God tok: “Una wey bi lie-lie profets dey make my pipol sin! If pesin give una food chop, una go sey make peace dey with am, but doz wey nor give una, una go won fight dem.
MIC 3:6 So, na only darkness una go dey si and una nor go get any vishon. Darkness go kover una kon end evry hope wey una get. Sun nor go shine for una profets head again a nd una life go end like dat.
MIC 3:7 Den shame and disgrace go follow una pipol wey dey si vishon. Una go kover una face, bikos God nor go ansa una.”
MIC 3:8 But na God pawa and spirit dey my body. E give mi sense to judge well with strent to take tell Israel pipol about dia sin.
MIC 3:9 Una wey bi leaders for Israel, make una listin to mi! Una hate to judge well and dey shange evritin wey dey rite.
MIC 3:10 Na blood and sin bi di foundashon wey una build Jerusalem put.
MIC 3:11 Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”
MIC 3:12 So, bikos of una, I go klear Zion like field; Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put and di temple go turn hill wey grass grow kover.
MIC 4:1 For di last days, di mountin where God temple dey, na-im go high pass all di mountins. E go high pass di hills too and pipol from evry nashon go dey rush go der go woship God.
MIC 4:2 Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.
MIC 4:3 God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.
MIC 4:4 Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!
MIC 4:5 Even doh di nashons around us dey serve dia juju, wi go woship and obey di Oga awa God forever and ever.
MIC 4:6 God sey, “Di time dey kom wen I go gada doz wey nor fit waka; wey bi slave for anoda kountry and doz wey nor happy at-all.
MIC 4:7 Doz wey dey weak, go survive and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry, go kon bi one strong nashon. Den mi wey bi God go rule Jerusalem as dia king forever.”
MIC 4:8 But Jerusalem; di place where nor-tin bad go happen to God pipol, yor royal strent and pawa go kom back again. Di king go get pawa for Jerusalem again.
MIC 4:9 But naw, wetin make una dey shaut and kry? Una nor get king to lead una? Abi dem don kill una wise men finish? So wetin make una dey feel pain like woman wey won born?
MIC 4:10 Jerusalem pipol, make una shaut and kry like woman wey won born, bikos dem must karry una go Babilon as slave. But God go save una for der; E go save una from una enemies hand.
MIC 4:11 Naw, many nashons don gada against una kon sey, “Make dem skata di town! Make wi look as dem dey distroy Jerusalem.”
MIC 4:12 But dem nor know wetin God dey tink; dem nor undastand en plans. Dis pipol nor know sey God dey gada dem, so dat dem go beat and mash dem pass like korn wey dem mash for groun.
MIC 4:13 God sey, “Jerusalem! Make yu raiz-up kon skata di nashons, bikos I go give yu iron and bronze horn, so dat yu go fit distroy many nashons! Yu go give di propaty and di money wey dem tif to Oga God wey dey rule di eart.”
MIC 5:1 Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
MIC 5:2 But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
MIC 5:3 God go give Israel pipol to dia enemies until di woman wey dey labor go born. Den en own kountry pipol go kom back to dia land from Babilon.
MIC 5:4 Wen e kom, e go lead di pipol with God strent, pawa and name. Den en pipol go stay for peace, bikos dem go dey honor am for evriwhere for di world.
MIC 5:5 E go give us peace. Wen Assyria pipol kom attack and break enter awa town, wi go choose seven rulers wey go wosh ova us and eight priests wey go lead us.
MIC 5:6 Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.
MIC 5:7 Den Israel pipol wey survive go bi like dew for morning wey God send kom di nashons; like rain wey go make plant grow and e nor dey wait for man before e fall.
MIC 5:8 Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.
MIC 5:9 Israel pipol go stand fight dia enemies kon kill all of dem finish.
MIC 5:10 God sey, “For dat time, I go kill una horse and distroy una shariot dem.
MIC 5:11 I go skata una wall kon distroy una pawa.
MIC 5:12 I go stop all di wiked tins wey una dey do and nobody go help una dey si vishon again.
MIC 5:13 I go distroy and skata una juju pilas, den una nor go ever woship di work wey una take una hand make.
MIC 5:14 I go skata una juju shrine with dia Asherah juju kon distroy una towns.
MIC 5:15 I go revensh and ponish all di nashons wey nor gri obey mi.”
MIC 6:1 Make una listin to wetin God dey tok: “Make una stand up kon tok wetin I do una. Make di mountins and hills bi witness to wetin una dey tok.
MIC 6:2 Naw, make di mountins listin to God! E get kase against en pipol. E go tok wetin Israel pipol do.
MIC 6:3 My pipol, wetin I do una? Wetin I do wey make una taya for mi? Make una ansa mi naw!
MIC 6:4 Na mi bring and save una from Egypt where una for bi slave. I send Moses, Aaron and Miriam kom help una.
MIC 6:5 My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”
MIC 6:6 Na wetin wi fit give God? Na wish kind ofrin wi won gi-am? Make wi bow woship God with melu ofrin?
MIC 6:7 Make wi gi-am tazon rams and 10,000 river wey full with olive oil? Make wi sakrifice awa first-born gi-am to take pay for awa sins?
MIC 6:8 No! My pipol, God don tell una wetin dey good and wetin E wont from una, na to dey do wetin dey rite; show love; dey obey and respet am.
MIC 6:9 If una dey wise, make una fear God! E dey koll evribody from Jerusalem sey: “Di sojas wey go distroy, dey kom and na God dey send dem kom so.
MIC 6:10 Wetin I wont tok about wiked pipol house wey full with propaty wey dem kollect thru wayo? Dem dey shit pipol for market and I hate dat kind tin.
MIC 6:11 How I won take bilive una wey dey sell and measure with wayo cup?
MIC 6:12 Di rish pipol among una dey get more money thru wayo and wikedness. Una pipol don too good with lie and trut nor dey dia tongue again.
MIC 6:13 So, I go wound una! I go distroy una, bikos of all di sin wey una don kommit.
MIC 6:14 Even wen una chop, e nor go ever beleful una and una go still dey hongry like sey una neva chop at-all. Even doh una dey try to save money, e nor go mean anytin for di end. Una go save small, but I go gi-am to doz wey go distroy una.
MIC 6:15 Even wen una plant, una nor go harvest anytin. Una go press una olive fruit, but una nor go get enough oil to anoint unasef. Una go mash di grape, but una nor go get any wine to drink.
MIC 6:16 Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”
MIC 7:1 E don finish for mi! I bi like pesin wey nor si fruit chop or si fruit pick afta dem don harvest evritin.
MIC 7:2 Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.
MIC 7:3 Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.
MIC 7:4 Even di pesin wey good pass among dem, bi like shuku-shuku; di one wey dey fear God pass among dem, wiked pass many shuku-shuku wey dem tie togeda. But di day wen God go judge dem, dey kom; di time wey E go ponish dem for evritin.
MIC 7:5 So make una nor trust anybody; even if di pesin na una best friend or wife!
MIC 7:6 Bikos boy pikin go rijet en papa and na so too girl pikin go rijet en mama. Wife go sey e nor know en husband mama and una enemy, go bi una family memba!
MIC 7:7 But as for mi, I bilive sey God go kom help mi. I dey wait for God with all my heart, so dat E go save mi. Yes! My God go hear mi.
MIC 7:8 So my enemies, make una nor happy, bikos of mi! Bikos wen ever I fall, I go raiz-up again. Even doh I dey for darkness, Oga God go bi my lite.
MIC 7:9 I go dey patient as God dey ponish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight for mi kon make mi win. God go take mi enter di lite and I go si en raitiousness.
MIC 7:10 Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.
MIC 7:11 For dat day, dem go ribuild Israel town and dia land go wide well-well.
MIC 7:12 Pipol go from difren land kom honor una; dem go kom from Assyria go rish Egypt town; from Egypt to Eufrates River and from di far sea go di mountins.
MIC 7:13 But di land go still dey empty and dirty go full am, bikos of di wiked tins wey doz wey dey stay der before, don do.
MIC 7:14 Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.
MIC 7:15 God sey, “Yes! I go do big mirakle among una; di kind ones wey I do wen I save una from Egypt where una for bi slaves.”
MIC 7:16 All di nashons for di world go stand sopraiz for wetin God go do for una. God mighty pawa go make dem konfuse. Dem go sopraiz kon kwayet dey look evritin wey dey happen.
MIC 7:17 Just as snake dey creep kom out from whole, na so too dem go fear kon turn kom meet di Oga awa God.
MIC 7:18 E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
MIC 7:19 Yes! Yu go sorry for yor pipol. Awa sins go dey under yor leg and Yu go trow dem go under di sea!
MIC 7:20 Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.
NAH 1:1 Dis na di message wey God give Nahum wey kom from Elkosh town and na about Nineveh pipol.
NAH 1:2 Oga God dey jealous well-well; E dey ponish doz wey dey oppoz am and E dey fight against en enemies!
NAH 1:3 Oga God nor dey kwik vex, but en pawa dey great. E go must ponish wiked pipol. E dey show en great pawa thru strong breeze and heavy rain. Na di kloud bi di dust wey dey under en leg.
NAH 1:4 God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.
NAH 1:5 For God present, mountins dey shake and hills dey melt trowey. Wons God appear, di eart go shake and evribody for di world, go fear.
NAH 1:6 Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.
NAH 1:7 Oga God dey good, E dey protet en pipol wen dem dey trobol and E dey kare for doz wey trust am.
NAH 1:8 But E go use heavy rain take distroy en enemies finish kon porshu dem enter darkness.
NAH 1:9 Wetin make una dey plan against God? Na wons E go distroy una finish and trobol nor go happen for di sekond time!
NAH 1:10 En enemies bi like dry shuku-shuku for bush. Yes! Dem bi like pesin wey don drink well-well. True-true, fire go burn dem like dry grass.
NAH 1:11 Na who bi dat wiked pesin for Nineveh wey dey plan against God?
NAH 1:12 So Israel pipol, dis na wetin God tok: “Even doh Assyria sojas get pawa and dem many well-well, I go distroy and skata dem finish for dis world. My pipol! I know sey I don ponish una before, but I nor go ponish una again.
NAH 1:13 Naw, I go skata and distroy Assyria pipol and dem nor go worry my pipol again.”
NAH 1:14 For Nineveh, God tok about Assyria pipol sey: “Una nor go get shidren wey go bear una name again. I go skata and distroy all di gods wey dey una temple and I dey prepare una grave, bikos una dey make mi vex!”
NAH 1:15 Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.
NAH 2:1 Nineveh pipol, somebody dey kom attack and skata una land. So, make una guide una town well-well and wosh una road too! Make una dey strong and ready to fight!
NAH 2:2 Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.
NAH 2:3 Na red dem take paint una enemies shield! Naw, make una si di red klot wey di sojas wear! Make una si as dia shariot dey run togeda and spear dey di sojas hand.
NAH 2:4 Di shariot dey run anyhow for di street. Dem bi like tonda lite and dem dey run fast-fast like lite wey flash pass.
NAH 2:5 Di king shaut koll en ofisas; dem dey run fall as dem dey rush go guide di town.
NAH 2:6 Dem don skata and open di river gate! Di palis go soon fall!
NAH 2:7 Dem don disgrace and karry Nineveh pipol go anoda land. Dem don drag dia kween go. En girls savant dey mourn for am; dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
NAH 2:8 Nineveh town full with pipol before, but naw, all di pipol don run komot. Even wen somebody shaut, “Make una stop! Make una nor run!” But nobody gri listin to am.
NAH 2:9 So naw, make una pak dia silva and gold, bikos Nineveh propaty many well-well! Nobody fit kount di money wey dem get.
NAH 2:10 Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!
NAH 2:11 So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.
NAH 2:12 Di lion dey kill wetin e katch kon tear dem to pieces for en wife and shidren. Na flesh full di lion house.
NAH 2:13 But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”
NAH 3:1 Curse dey di town wey full with innocent pipol blood! Na lie-lie and propaty wey dem tif, naim full der and na to kill pipol bi dia work.
NAH 3:2 Make una listin as di pipol wey dey drive di shariot, dey whip di horse dem as dem dey kom di town and as dia taya dey shake di groun.
NAH 3:3 Dem dey ready to kill. Dia swod and spear dey shine as dem dey kill pipol for evriwhere. Nobody fit kount di pipol wey dem kill and doz wey remain dey run fall on-top di dead body dem.
NAH 3:4 All dis tins dey happen, bikos Nineveh pipol too do ashawo, dem don sharm odas nashons and make dem dia slave.
NAH 3:5 Oga God sey, “I bi una enemy! Naw, I go let all di nashons si una nakednes, den shame go katch una.
NAH 3:6 I nor go trit una with respet, instead I go kover una with dirty kon turn una to wetin pipol go dey look kon dey laf.
NAH 3:7 Evribody wey si una go-go back kon sey, ‘Nineveh own don finish! Where dia pipol wey dey kill odas? Who dey kry sey dem distroy una?’ ”
NAH 3:8 Nineveh, una betta pass Tebes town near River Nile? Na di river bi di wall wey dey protet am.
NAH 3:9 Na Ethiopia and Egypt bi Tebes pawa before and nor-tin fit stop am; bikos Libya and Put pipol dey kom support am too.
NAH 3:10 Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.
NAH 3:11 Naw, Nineveh, yorsef go stagga fall like who don drink. Yu go run go hide from yor enemies, den yu go kom dey beg for help.
NAH 3:12 All wetin dey guide yu, go fall. Dem go skata dem fall like fig fruit wey don ripe: wons dem shake di tree, di fruit go fall enter dia mout.
NAH 3:13 Una sojas weak like woman wey nor get who to help am. Dem go open una town gate for una enemies and dem go put fire kon burn am rish groun.
NAH 3:14 Naw, dem dey attack una town, so make una fetch enough wota! Make una defend una town well-well kon make betta stones with mud, den ripair di fence.
NAH 3:15 But know matter wetin una do, fire go still kill una; una enemies go kill una like lokust. Dem go kill evritin wey dem si and una nor go fit eskape, even if una plenty like many lokust.
NAH 3:16 Una tradas many! Dem plenty pass stars for sky! But dem go fly go like lokust.
NAH 3:17 Una prince and ofisas bi like plenty ant. Dem dey gada togeda for one place bikos di weda dey kold. But wons sun kom out, dem go fly go kon disappear!
NAH 3:18 Assyria king! Yor leaders don die and yor ofisas don sleep go forever! Yor pipol skata on-top di mountin and nobody dey to bring dem kom house again.
NAH 3:19 Yor sore nor get cure and nobody go fit heal yu again. Doz wey hear as dem take distroy yu, dey klap and sing with joy, bikos yor wahala and trobol, too mush.
HAB 1:1 Dis na di message wey God give Profet Habakkuk:
HAB 1:2 Oga God, e don tey wen I dey kry make Yu kom help mi, but Yu nor gri ansa! I kry sey, “Trobol dey evriwhere!” But Yu nor still gri kom save mi.
HAB 1:3 Why Yu allow mi dey face dis kind trobol? Must I si all dis wahala wey dey happen to mi? Anywhere wey I look, na only wahala and distroshon I dey si. Na pipol wey love to kworel and fight, dey round mi.
HAB 1:4 Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.
HAB 1:5 God ansa, “Make yu look di nashons well and wetin yu go si, go sopraiz yu! I go do sometin naw wey yu still dey alive and even wen pesin tell yu, yu nor go bilive.
HAB 1:6 I won give Babilon pipol pawa; doz wiked pipol wey nor dey sorry for odas. Dem go mash round di world kon seize all di oda nashons.
HAB 1:7 Pipol dey fear dem well-well and dem dey do wetin dem like.
HAB 1:8 Dia horse fast pass leopard and e wiked pass wolf for desert. Dia men dey ride di horse kom; dem bi like eagle wey dey rush go kill en enemy.
HAB 1:9 All of dem dey kom with wahala; dey rush dey kom like breeze for desert and dem go gada di pipol wey dem katch like sey dem dey gada san.
HAB 1:10 Dem dey ponish kings and use dia leaders make yeye. Dem dey laf all dia strong-strong towns. Dem dey kover towns with san-san kon seize dem.
HAB 1:11 Dem dey pass like breeze wey dey blow. But dem really dey guilty, bikos dem bilive sey, na dia pawa as dia god.”
HAB 1:12 My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.
HAB 1:13 Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?
HAB 1:14 Yu dey trit pipol like fish for sea or like animal for wota wey nor get who dey kontrol dem.
HAB 1:15 Babilon pipol dey hook and katch pipol like fish kon karry dem go for net as dem dey happy bikos of wetin dem katch.
HAB 1:16 Dem even dey woship and offa sakrifice give dia net kon dey sey, “Na dis net bi di god wey make us get money well-well!”
HAB 1:17 Yu go allow dem ponish pipol forever? Dem go dey distroy nashons forever?
HAB 2:1 I go stand for where I for dey guide and look well-well. I go wait make I for know wetin God go tell mi and how E go take ansa my komplain.
HAB 2:2 So God ansa: “Di vishon wey I dey tell yu naw, make yu rite am down make e klear, so dat anybody wey read am, go undastand am well-well.
HAB 2:3 Make yu rite am even doh e neva rish time for di vishon to happen. But di time go soon rish and wetin I show yu, go happen. E fit bi like sey e nor go happen, but make yu wait; e go must happen and e nor go tey again.
HAB 2:4 Si proud pipol, all wetin dem dey do nor dey good for my eye. But doz wey dey do good, go get long life, bikos dem dey obey my laws.
HAB 2:5 True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.
HAB 2:6 “But very soon, di pipol wey dem katch, go ponish who katch dem. Dem go sey, “ ‘Una take wetin nor bi una own and naw, una own don finish! But na how long dis kind tin go kontinue?’
HAB 2:7 Den pipol wey una dey whole money, go kom kollect dia money. Dem go turn face una kon take evritin wey una get.
HAB 2:8 Una don tif from many nashons, so doz wey still dey alive, go tif from una. Una don kill pipol kon kause wahala for di whole world.
HAB 2:9 So e betta make una die, dan to dey build big-big house with money wey una tif. Una do like dis, so dat una go fit run from wahala and trobol.
HAB 2:10 Una don disgrace unasef and una life don finish, bikos of di pipol wey una kill and as una take distroy many nashons, na so too dem go distroy una.
HAB 2:11 Even di stones for wall and ceiling dey kry and komplain against una.
HAB 2:12 Una wey build town with money wey una play wayo and kill pipol take get, na curse go follow una.
HAB 2:13 But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.
HAB 2:14 Just as wota full sea, na so too dem go know about God glory for evriwhere for dis world.
HAB 2:15 Una wey dey make una neighbours drink too mush, so dat dem go naked and disgrace demsef, na big curse dey una head.
HAB 2:16 Instead make dem honor una, na disgrace go follow una and na una by unasef go drink kon stagga fall. God go make una drink from una own ponishment cup and una honor go turn to disgrace.
HAB 2:17 Just as una distroy Lebanon, na so too dem go distroy una finish. Una kill all di animals wey dey der, but naw, animals go worry and kill una. Dis tin go happen, bikos of di pipol wey una kill and di wahala wey una kause for dis world.
HAB 2:18 Na wetin juju dey good for? Nor bi sometin wey pesin make with en hand? Na wish good e do wey go make who make am, trust am? Na god wey nor fit tok!
HAB 2:19 Curse dey una head! Una dey tell ordinary wood and stone sey, ‘Make una wake-up kon save us!’ Juju go fit tell una anytin? Dem fit make am with silva and gold, but e nor get life at-all.
HAB 2:20 But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”
HAB 3:1 Dis na di prayer wey Profet Habakkuk pray:
HAB 3:2 My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.
HAB 3:3 God dey kom from Teman; God wey dey holy dey kom from Mount Paran. En glory kover di heavens and na en praiz full di eart.
HAB 3:4 E dey shine like sun as E dey kom and lite dey shine from en hand, where en pawa der.
HAB 3:5 E send diziz go for en front kon kommand deat follow am for back.
HAB 3:6 Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.
HAB 3:7 I si Kushan pipol dey fear and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.
HAB 3:8 My God, na di sea make Yu dey vex? Yu really dey vex for di river dem? No! Yu dey kom with yor shariot kon save us!
HAB 3:9 Yu dey ready to use yor bow kon shot yor arrow. Yor lite for heaven dey divide di eart into two.
HAB 3:10 Mountins dey fear as dem si Yu; rain dey fall from di kloud and waves for sea dey raiz and make nois bikos of Yu.
HAB 3:11 As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.
HAB 3:12 Yu vex mash pass di eart and as Yu dey vex, Yu kon skata all di nashons.
HAB 3:13 Yu go save yor pipol and di king wey Yu choose. Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol kon distroy doz wey dey follow am.
HAB 3:14 Wen en sojas gada dey kom like strong breeze to kom skata and opress us, Yu kill dem with yor arrow.
HAB 3:15 Yu mash di sea with yor horse and di mighty river kon dey foam.
HAB 3:16 I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.
HAB 3:17 Even doh di fig and olive tree nor get fruit naw and di grape nor gri grow for di vine or sey di land produce korn and all di animals don die,
HAB 3:18 I go still dey happy and sing for joy, bikos na Oga God dey guide mi.
HAB 3:19 God wey get pawa dey give mi strent. E make mi stand strong for groun like deer kon keep mi save on-top di mountin. (For di kwayamasta: Make dem sing dis song with instrument like, jita.)
ZEP 1:1 Dis na di message wey God give Zefanaya for di time wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah. Kushi wey bi Gedalaya pikin, naim bi Zefanaya papa and na Amaraya wey bi Hezekaya pikin, born Gedalaya.
ZEP 1:2 God sey, “I go swip evritin komot from dis eart.
ZEP 1:3 I go swip both pipol and animals. I go distroy di birds for di sky and di fish for sea. I go turn wiked pipol place to where dem dey trowey dirty put kon distroy human being komot from dis eart.
ZEP 1:4 Na with my hand I go take skata Judah, Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju wey dem dey woship. I go distroy all dia wiked priests and nobody go remember dem again,
ZEP 1:5 bikos dem klimb on-top dia house go bow for di sun, moon and stars. Dem dey klaim sey dem dey follow God, but dem still dey woship Molek juju.
ZEP 1:6 I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”
ZEP 1:7 So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.
ZEP 1:8 God sey, “For judgement day, I go ponish Judah leaders, all dia prince and all doz wey dey sin.
ZEP 1:9 For dat day, I go ponish di pipol wey dey serve juju and wey turn dia oga house to where dem dey kworel and play pipol wayo.”
ZEP 1:10 God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.
ZEP 1:11 All of una wey dey stay near di market, make una kry with pain, bikos I go distroy all doz wey dey sell and buy.
ZEP 1:12 I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.
ZEP 1:13 So, pipol go tif and karry dia propaty kon skata dia house. Dem go build new house, but dem nor go ever stay inside. Dem go plant vineyard, but dem nor go ever drink from di wine.
ZEP 1:14 Di day wey God go make evribody fear, don near. E go kom kwik-kwik and nobody go like am, bikos for dat day, even strong men go kry.
ZEP 1:15 Dat day, God go vex well-well and di wahala and pain nor go eazy at-all. Dat day go bi to skata and distroy; day wen evriwhere go dark well-well. Yes! Dat day go kom with tick kloud and darkness.
ZEP 1:16 For dat day, trumpet go dey blow and war go dey evriwhere. Evriwhere for di town go dey shake; even di walls wey strong well-well, go fall skata!
ZEP 1:17 Bikos una don sin against God, I go make una waka dey find road like blind man. Dem go pour una blood for san-san and una body go rotin for groun.”
ZEP 1:18 Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.
ZEP 2:1 Dis nashon wey nor get shame, make una gada togeda.
ZEP 2:2 Make una gada before judgement go start; before una time to turn from sin kom meet God go pass, just like wen breeze blow leaf trowey. Make una do di rite tin naw, before God vexnashon go fall on-top una and before en judgement go start.
ZEP 2:3 Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.
ZEP 2:4 Dem go distroy Gaza and Ashkelon kon skata Ashdod and Ekron town.
ZEP 2:5 Curse dey Filistia pipol head wey dey near di river and doz wey dey Kanaan land, bikos dis judgement na against una two! God go distroy all of una finish.
ZEP 2:6 Filistia town go turn to wildaness where animals dey stay and chop grass.
ZEP 2:7 Doz wey remain for Judah go stay for der. Dem go stay and dey chop for di house wey Ashkelon pipol run leave. Oga God go visit en pipol with kindness and make dem prosper again.
ZEP 2:8 I don hear as Moab pipol dey trobol my pipol and di way Ammon pipol dey curse, laf and attack dem for where dem dey stay.
ZEP 2:9 Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”
ZEP 2:10 Na di reward for dia pride bi dat, bikos dem don curse di pipol wey bi Oga God own.
ZEP 2:11 God go make dem fear as E dey distroy all di gods for di land.
ZEP 2:12 God sey, “Ethiopia pipol, I go kill all of una with my swod.”
ZEP 2:13 I go skata di land for nort with my hand kon distroy Assyria land too. I go turn Nineveh, di main town to where dem dey trowey dirty put and e go bi desert.
ZEP 2:14 Grass and wild animals go full di town. Owls go dey play for der and dem go dey shaut thru di windows. Dirty go block all di road wey dem dey pass enter di town and all di fine-fine buildings, go fade finish.
ZEP 2:15 Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.
ZEP 3:1 Bad tins go happen to Jerusalem pipol, bikos dem don spoil di town kon turn am to where wayo full.
ZEP 3:2 Nobody fit tell am anytin, bikos e nor dey gri make dem korrect am. E nor trust God at-all and e nor dey listin to am.
ZEP 3:3 En leaders bi like hongry lion wey dey look for who dem go chop. Dem dey hongry like wolf for desert wey dey chop dia food finish for morning.
ZEP 3:4 En profets sturbon and dem dey lie; dey tok only wetin go give dem money. En priests nor gri obey God kommand, so dem don spoil and make di temple dirty with di bad tins wey dem dey do.
ZEP 3:5 But God still dey di town and E nor dey do bad at-all. E dey always judge matter well and E nor dey fail. Yet wiked pipol nor dey shame at-all.
ZEP 3:6 God distroy many nashons kon skata di walls for dia town. E skata dia street and nobody dey waka pass der again. Dia town don skata and nobody dey stay inside again.
ZEP 3:7 God sey, “I bin tink sey, ‘Una go really respet mi!’ Naw, make una do wetin I tok! If to sey una really gri do am, dem nor for skata una house with all dis ponishment.” But na only to sin una dey tink about.
ZEP 3:8 So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.
ZEP 3:9 Make una know sey, for dat time, I go make di nashons praiz mi well-well. All of dem go dey pray with my name kon woship mi with one spirit.
ZEP 3:10 My pipol wey skata before, go from di oda side for Ethiopia river kon sakrifice give mi.
ZEP 3:11 For dat day, una nor go dey shame bikos of all una sturbones against mi. I go distroy doz wey dey boast among una and una nor go ever dey sturbon for my holy hill again.
ZEP 3:12 Pipol wey dey honbol and good, na dem go stay with una and dem go dey save for God present.
ZEP 3:13 Israel pipol wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipol, nor go dey dia mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well and nor-tin go make dem fear again.
ZEP 3:14 Una wey dey Zion, make una shaut! Israel pipol, make una shaut too! Jerusalem pipol, make una dey happy and boast with all una heart!
ZEP 3:15 God nor go judge una again; E don drive una enemies from una. Israel king, God dey with yu! So una nor nid to fear again.
ZEP 3:16 For dat day, dem go tell Jerusalem, ‘Zion, make yu happy! Make yu nor fear at-all!
ZEP 3:17 Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’
ZEP 3:18 But doz wey dey kry bikos dem nor fit go di festival, I don take dem komot from among una; so dat dem nor go disgrace una again.
ZEP 3:19 And for dat time, I go ponish doz wey dey trit una anyhow. I go save di pipol wey dey weak and gada dem togeda. I go remove dia disgrace and dis go make di whole world dey respet dem!
ZEP 3:20 For dat time, I go gada and bring una kom back to una house. Wen I dey give una evritin wey una don lost before, I go make evribody for dis world respet and honor una.”
HAG 1:1 For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
HAG 1:2 Oga God wey dey lead Heaven Sojas tell Haggai sey, “Dis pipol dey sey dis nor bi di rite time to build di temple again.”
HAG 1:3 So God sey make Profet Haggai go give di pipol dis message:
HAG 1:4 “My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”
HAG 1:5 Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!
HAG 1:6 Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.
HAG 1:7 “God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’
HAG 1:8 So, make una go di mountins go kut wood kon ribuild di temple; den I go dey happy and belle go sweet mi.”
HAG 1:9 “Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.
HAG 1:10 Na dis tin make rain nor fall for di eart, so anytin wey una plant, nor dey grow.
HAG 1:11 Yes, I don sey rain nor go fall for una land, hills, farm, vineyard, olive trees and for evritin wey di groun dey produce for una and una animals. I go skata evritin wey una dey work hard to get.”
HAG 1:12 So, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin with Joshua, Jehozadak pikin wey bi di High Priest and evribody wey kom back from Babilon kon obey Oga God message wey E tell dem thru Profet Haggai and dem kon dey follow and obey God word, well-well.
HAG 1:13 Den Haggai tell di pipol, “God sey: ‘I promise sey I go dey with una.’ ”
HAG 1:14 So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work
HAG 1:15 for di twenty fourt day for di sixt mont for di sekond year wey Darius bi king for Persia.
HAG 2:1 For di twenty first day for di sevent mont for dat same year, God kon tok to Profet Haggai again.
HAG 2:2 E tell am make e go tell Zerubabel wey bi Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah, Joshua wey bi di High Priest and all di pipol sey,
HAG 2:3 “E get anybody among una wey fit remember di way di temple fine rish before? But how una si am naw? Una fit kompare dis temple with di first one?
HAG 2:4 But naw, Oga God sey: Zerubabel make yor heart strong, Joshua, Jehozadak pikin wey bi High Priest, make yu don fear too. All di pipol wey dey di land, make una mind strong. Make una bigin work, bikos I dey with una.
HAG 2:5 My Spirit still dey with una, just as I promise wen una dey kom out from Egypt, so make una nor fear.
HAG 2:6 Dis na wetin Oga God for heaven dey tok: E nor go tey again before I go shake di heavens and di eart, di sea and di dry land.
HAG 2:7 I go shake all di nashons and dem go bring all dia propaty kom dis temple. I go kover dis place with my glory.”
HAG 2:8 God sey, “Na mi get all di silva and gold wey dey di world.
HAG 2:9 Di glory for dis new temple go big pass di old one and na for der I go for give my pipol peace and make dem prosper.”
HAG 2:10 For di twenty fourt day for di ninet mont for di sekond year wey Darius bi king, Oga God tok to Profet Haggai again.
HAG 2:11 E sey, “Make yu go ask di priest wetin di law tok about dis tin:
HAG 2:12 ‘Like for ezample sey pesin take holy meat wey dem don sakrifice kon hide am for en klot, den e allow dat klot tosh bread or food wey dem kook or wine or olive oil or any kind food, dat one go make di food dey holy?’ ” So wen Haggai ask dem di kweshon. Di priests ansa, “No!”
HAG 2:13 Den Haggai ask again, “Wot of pesin wey dirty bikos e tosh dead body; if e tosh any of dis food, dat mean sey di food dem don dirty too?” Di priests ansa, “Yes!”
HAG 2:14 Den Haggai sey, “God sey na di same tin go happen to di pipol for dis nashon and evritin wey dem plant. So evritin wey dem offa for di altar, don dirty.”
HAG 2:15 So God sey, “Make una tink about wetin bin dey happen to una before una start to ribuild di temple. But from naw go, evritin wey una dey do, go dey okay.
HAG 2:16 Dat time, una go where dem pak korn full, dey tink sey una go si twenty sak, but na only ten una si. Una go draw fifty gallon for wine, but na only twenty una get.
HAG 2:17 Even wen I send hot breeze and big-big stones kom skata evritin wey una plant, una nor still gri turn from sin kom meet mi.
HAG 2:18 But from today wey bi di twenty fourt day for di ninet mont, make una tink about how e bi before and naw wen una don build di temple again. Make una always dey tink of am.
HAG 2:19 Una korn, grapevines, fig trees, pomegranates and olive tree nor dey produce food since, but from naw go, I go bless una.”
HAG 2:20 For dat same day wey bi di twenty fourt day for di mont, God give Haggai anoda message
HAG 2:21 make e go tell Zerubabel wey bi govnor for Judah: “I go soon shake heaven and eart
HAG 2:22 kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.
HAG 2:23 For dat day, I go take yu, Zerubabel, Shealtiel pikin wey bi my savant kon make yu rule with my name, bikos na mi choose yu.”
ZEC 1:1 For di eight mont for di sekond year wey Darius dey rule for Persia, God give dis message to Profet Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.
ZEC 1:2 Mi wey bi God, bin dey vex well-well for una grand-grand papa dem,
ZEC 1:3 so make yu tell di pipol sey, “Dis na wetin God wey dey lead heaven sojas tok: ‘Make una turn kom meet mi and I go kom meet una too, dis na wetin Oga God wey dey rule ova evritin, tok.’
ZEC 1:4 Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.
ZEC 1:5 Where una grand-grand papa dem naw? Dem with di profets don die since.
ZEC 1:6 But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”
ZEC 1:7 For di sekond year wey Darius dey rule, for di twenty fourt day, for di elevent mont wey bi Shebat, God give dis message to Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.
ZEC 1:8 For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.
ZEC 1:9 Den I ask, “Oga God, wetin all dis horse mean?” E ansa, “I go show yu wetin dem mean.”
ZEC 1:10 Den di man wey stand near di myrtle tree kon sey, “Na God send dem make dem go look how di eart bi.”
ZEC 1:11 So dem go back kon tell di angel, “Wi don go round di eart kon si sey peace dey evriwhere.”
ZEC 1:12 Den di angel pray to God, “Oga God wey dey mighty, Yu don dey vex for Jerusalem and Judah town for seventy years naw. How long e go take before Yu go sorry for dem?”
ZEC 1:13 So God ansa di angel wey dey tok to mi with words wey dey make belle sweet pesin.
ZEC 1:14 So di angel kon tell mi, “Make yu go tell evribody wetin God tok, ‘I love and dey koncern about Jerusalem and Zion wey bi my holy town,
ZEC 1:15 but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.
ZEC 1:16 “ ‘So I don kom back to Jerusalem town kon show dem mesi. Dem go build my temple and di town again.’ ”
ZEC 1:17 Di angel still sey: “God go help Jerusalem and make di town prosper again and di town go bi en own.”
ZEC 1:18 Den wen I look up again, I kon si four horns.
ZEC 1:19 I ask di angel wey dey tok to mi, “Wetin dis horn dem mean?” E ansa, “Dem stand for di wiked pawas for di world wey skata Judah, Israel and Jerusalem pipol.”
ZEC 1:20 Den God kon show mi four men wey bi karpenter.
ZEC 1:21 I kon ask, “Wetin dis men dey kom do?” E ansa, “Dem dey kom treaten Judah enemies and skata di horns wey won distroy Judah pipol.”
ZEC 2:1 Den I look again kon si one man whole ruler wey dem take dey measure.
ZEC 2:2 So I ask am, “Where yu dey go?” E ansa, “I dey go measure Jerusalem, make I for know as e wide and long rish.”
ZEC 2:3 Den di angel wey dey tok to mi kon waka go front and anoda angel kom meet am.
ZEC 2:4 Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’
ZEC 2:5 God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”
ZEC 2:6 God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere.
ZEC 2:7 Zion pipol, make una eskape and run komot Babilon!
ZEC 2:8 Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.”
ZEC 2:9 God sey, “I go ponish dem well-well and na dia own slave go distroy and pak dia propaty.” Den una go know sey na Oga God wey dey rule ova evritin send mi kom.
ZEC 2:10 So Zion pipol, make una shaut and happy as una dey sing, bikos I dey kom meet and stay with una.
ZEC 2:11 For dat time, many nashons go kom meet God and dem go bi en pipol. God go stay with una, den una go know sey na God send mi kom.
ZEC 2:12 Judah go bi God special propaty for en holy land again, den Jerusalem go bi di town wey God choose.
ZEC 2:13 So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.
ZEC 3:1 For anoda vishon; I si Joshua wey bi di High Priest stand for God angel front; Satan too stand for Joshua rite hand side and e dey akuiz am.
ZEC 3:2 So Oga God tell Satan, “Satan! Mi wey bi God rijet all wetin yu tok. Yes! God wey love Jerusalem go kondemn yu. Dis man nor bi like stik wey dem take komot from fire?”
ZEC 3:3 Joshua still stand near di angel with di dirty klot wey e wear.
ZEC 3:4 Den di angel tell doz wey stand near am, “Make una pul di dirty klot wey dis man wear so, komot from en body.” Den e tell Joshua, “I don forgive yu all yor sins and naw, I go give yu new klot make yu wear.”
ZEC 3:5 Den I sey make dem wear klean crown for Joshua head. Dem do as I tok kon wear new klot for am too and God angel stand near us.
ZEC 3:6 Den God angel enkourage and tell Joshua,
ZEC 3:7 “God wey dey mighty sey, ‘If yu obey my laws kon keep my kommands, na yu go bi oga for my temple and for my kourt and I go add yu join all dis angels wey dey my side naw.’
ZEC 3:8 Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”
ZEC 3:9 “Si, I dey put one stone wey get seven eye for Joshua front. I go rite put kon remove all di sin wey dis land don kommit.
ZEC 3:10 And for dat day, una go invite una neighbours make dem kom sidan with una under una vine and fig tree, bikos una go get peace.”
ZEC 4:1 Den di angel wey bin dey tok to mi kom back kon wake mi just as dem dey wake pesin wey dey sleep.
ZEC 4:2 E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.
ZEC 4:3 Two olive tree dey near di lampstand too; one for each side.”
ZEC 4:4 Den I ask di angel wey tok to mi, “My oga, wetin dis tins mean?”
ZEC 4:5 E ansa, “So yu nor know wetin all dis tins mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
ZEC 4:6 Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’
ZEC 4:7 “Even di strongest mountin nor go fit stand fight Zerubabel, bikos di mountin go turn ordinary groun for en front! And wen Zerubabel don put di final stone for where e suppose dey for di temple, di pipol go shaut, ‘Make God bless am! Make God bless di temple well-well!’ ”
ZEC 4:8 Den God tell mi anoda message:
ZEC 4:9 “Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.
ZEC 4:10 Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
ZEC 4:11 Den I ask di angel, “Na wetin bi dis two olive tree wey dey each side for di lampstand
ZEC 4:12 and di two olive branches wey dey pour gold oil kom out from di two gold pipe?”
ZEC 4:13 Di angel ansa, “So yu nor know wetin dem mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
ZEC 4:14 Den e tell mi, “Na dem bi di two pesin wey dem anoint for heaven to serve Oga wey bi God for di whole eart.”
ZEC 5:1 I look up again and I kon si one book dey fly for di sky.
ZEC 5:2 Den di angel ask mi, “Wetin yu dey si?” I ansa, “Na book wey dey fly and e long rish thirty fit kon wide rish fifteen fit.”
ZEC 5:3 Den di angel tell mi, “Dem rite all di curse wey dey di land inside di book. For one side for di book, dem rite put sey, ‘Anybody wey dey tif, dem go drive am komot di land,’ and for di oda side, wetin dem rite put na, ‘Anybody wey dey lie, dem go drive am komot di land too.’ ”
ZEC 5:4 Oga God sey, “Doz wey dey tif and lie, I go send dis curse go meet dem for dia house and di curse go stay and distroy dem finish.”
ZEC 5:5 Leta, di angel kon tell mi again, “Make yu look! Anoda tin dey kom!”
ZEC 5:6 So I ask, “Wetin bi dat?” E ansa, “Na basket and na di whole land sin full inside.”
ZEC 5:7 Den dem open di heavy kover wey dem take kover di basket and as I look am, na one woman sidan for inside!
ZEC 5:8 Den di angel sey, “Dis woman name na, ‘Wikedness.’ ” So e push di woman enter di basket back kon kover am.
ZEC 5:9 I look up again kon si two wimen dey fly kom meet us and dem get strong feada like bird own. Dem pick di basket kon fly go with am.
ZEC 5:10 So I ask di angel, “Di basket and di woman wey dey inside, na where dem dey karry dem go?”
ZEC 5:11 Di angel ansa, “Na Babilon and dem go build temple for am for der. Wen dem don build di temple finish, dem go put di basket for der.”
ZEC 6:1 I look up again and dis time, I si four shariot dey kom out from di centre for two bronze mountin.
ZEC 6:2 Na red horses dey drag di first shariot, while black horses dey drag di sekond shariot.
ZEC 6:3 Na white horses dey drag di third one and na horses wey get spots for body dey drag di fourt one.
ZEC 6:4 Den I ask di angel wey dey tok to mi, “My oga! Na wetin dis shariot dem mean?”
ZEC 6:5 E ansa, “Dis na di four spirit for heaven wey dey stand for God wey kreate di world front.” Dem dey go do en work.
ZEC 6:6 Di shariot wey di black horse dey drag, dey go nort; di white horse dey go west and di horse wey get spots dey go di kountries for sout.
ZEC 6:7 As di strong horse dem kom out, dem rush dey go patrol di eart. Di angel kon tell dem, “Make una go patrol di eart well-well!” So dem kon go.
ZEC 6:8 Den Oga God koll and tell mi, “Si, di shariot wey go di nort side don make mi stop to vex for di pipol for di land.”
ZEC 6:9 God give mi dis message:
ZEC 6:10 “Make yu take Heldai, Tobaya and Jedaya wey kom back from Babilon with di oda pipol, den go meet Josaya wey bi Zefanaya pikin for en house.
ZEC 6:11 Yu go use di silva and gold wey dem bring as gift take make crown, den crown Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
ZEC 6:12 Make yu tell am, ‘God wey get pawa sey, “Dis na di man wey dem dey koll di Branch, e go prosper kon build God temple again.
ZEC 6:13 Naim go build di temple kon take di praiz wey suppose bi di king own and e go rule en pipol. One priest go stand near en throne and dem go work togeda with peace and undastandin.
ZEC 6:14 Na di crown dem go take honor and remember Heldai, Tobijah, Jedaya and Josaya for God temple.
ZEC 6:15 Pipol from far go kom join build God temple again. And wen dem don build am finish, yu go know sey na God wey dey mighty send mi kom meet yu. All dis tins go happen if yu use yor whole heart take obey all wetin di Oga yor God kommand yu.” ’ ”
ZEC 7:1 For year afta Darius don bi king, for di fourt day for di ninet mont wey dem dey koll Kislev, God kon give mi dis message.
ZEC 7:2 For dis time, Bethel pipol don send Shareza, Regemelek and dia men go pray to God make E for bless dem.
ZEC 7:3 Den make dem still ask di priests and profets dis kweshon: “Make wi kontinue to mourn and fast for di fift mont just as wi dey do since?”
ZEC 7:4 So Oga God wey dey lead heaven sojas kon tell mi:
ZEC 7:5 “Make yu ansa di pipol and di priests, ‘Since una dey fast for di fift and sevent mont for seventy years naw, una really dey do am bikos of mi?
ZEC 7:6 And naw wey una dey chop and drink, nor bi for una own body?
ZEC 7:7 Dis nor bi di same message wey God tell una thru en profets before-before wen Jerusalem and Judah town dey stay for peace and wen Negev and Judah pipol still plenty?’ ”
ZEC 7:8 So God kon give dis message to Zekaraya:
ZEC 7:9 “Oga God wey dey rule evritin sey, ‘Make una dey judge well, show kindness and sorry for odas.
ZEC 7:10 Make una nor opress wimen wey dia husband don die; shidren wey nor get papa and mama; strenjas wey dey una town; doz wey nid una help and make una nor plan bad against each oda.’
ZEC 7:11 “But dem nor gri listin, instead dem klose dia ear make dem for nor hear anytin.
ZEC 7:12 Dia heart strong like rock and dem nor gri obey my profets wey dey among dem. So I vex kon ponish dem well-well.
ZEC 7:13 “Bikos dem nor gri listin wen I tok to dem, na so too I nor go listin anytime wey dem pray to mi.
ZEC 7:14 Instead, I go skata and karry dem go difren kountry like sey na heavy breeze blow dem. Den dis betta land go turn where pipol nor dey stay again and where dem dey trowey dirty put.”
ZEC 8:1 Den Oga God wey dey lead heaven sojas give Zekaraya dis message:
ZEC 8:2 “Dis na wetin God wey dey lead heaven soja tok: ‘I dey always like to bless Zion, bikos of di strong love wey I get for en pipol and na dis love dey make mi vex for dia enemies.’ ”
ZEC 8:3 And naw, Oga God sey, “I dey go back to Jerusalem kon stay for Zion wey bi my holy town. Den pipol go koll Jerusalem ‘Di town wey dey faithful’ and dem go koll Oga God mountin, ‘Di holy mountin.’ ”
ZEC 8:4 Oga God wey get pawa sey, “Old men and wimen wey dey Jerusalem, go waka round di town with dia walkin stik and dem go sidan for di town centre again.
ZEC 8:5 Boys and girls go full di strits kon dey play again.”
ZEC 8:6 God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol wey remain fit tink sey all dis tins nor dey possibol, but with mi wey bi Oga God wey get pawa well-well, evritin dey possibol.”
ZEC 8:7 God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol, make una dey sure sey I go save una from di land wey dey east and west.
ZEC 8:8 I go bring una kom back to una house and una go get peace for Jerusalem. Una go bi my pipol and I go bi una God wey go rule and judge una well.”
ZEC 8:9 God wey dey lead heaven sojas sey, “Make una dey strong kon finish di work! Na since dem start to build God Temple, una don hear wetin di profets dey tok about how di temple work go take komplete.
ZEC 8:10 Before dat time, nobody get money to hire men or animals and nobody dey save from en enemies, bikos na mi God turn pipol against each oda.”
ZEC 8:11 But naw, God wey dey lead heaven sojas sey, “As for my pipol wey remain, I go dey trit dem well.
ZEC 8:12 Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.
ZEC 8:13 Judah and Israel pipol! Before-before, strenjas dey curse diasef sey, ‘Make di kind wahala wey fall press Judah and Israel pipol, fall press yu!’ But I go save una and doz strenjas go still tell each oda sey, ‘Make yu receive di same blessing wey Judah and Israel pipol get!’ So make una get hope and nor fear.”
ZEC 8:14 Oga God sey, “I plan to distroy una grand-grand papa dem wen dem make mi vex and I do just as I plan.
ZEC 8:15 But naw, I dey plan to bless Judah and Jerusalem pipol. So make una nor fear.
ZEC 8:16 But dis na wetin una go do: ‘Make una always dey tell each oda di trut. Make una judge well, di kind judgement wey dey bring peace.
ZEC 8:17 Make una nor plan bad against each oda or swear as una dey tok wetin una eye nor si. I hate lie, opreshon and doz wey dey kause wahala.’ ”
ZEC 8:18 Oga God tell Zekaraya sey,
ZEC 8:19 “Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”
ZEC 8:20 Oga God wey dey rule ova evritin sey, “Di time dey kom wen pipol from difren kountries go kom Jerusalem.
ZEC 8:21 Pipol from one kountry go tell doz from anoda kountry sey, ‘Wi dey go woship Oga God wey get pawa kon pray make E bless us. So make una kom follow us go!’
ZEC 8:22 Many pipol and strong nashons go kom Jerusalem kon woship and pray to God wey get pawa, so dat E go bless dem.”
ZEC 8:23 God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”
ZEC 9:1 Na Oga God give mi dis message against Hadrak and Damaskus town. Evribody dey look up to God make E bless dem, especially Israel pipol.
ZEC 9:2 God go judge di pipol wey dey Hamat with Damaskus, Tyre and Sidon pipol wey share boundary with dem, bikos dem tink sey dem wise well-well.
ZEC 9:3 Tyre pipol build strong house for demsef kon gada many gold and silva like sey na san-san!
ZEC 9:4 But God go take evritin wey dem get from dem. E go trow all dia propaty for sea and dem go burn di town rish groun.
ZEC 9:5 Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.
ZEC 9:6 Na strenjas go stay for Ashdod town and I go really distroy Filistia pipol, bikos dem too dey karry body up.
ZEC 9:7 “Dem nor go chop meat wey nor get blood again or food wey my pipol dey forbid. All di pipol wey survive, go bi my pipol too and dem go bi one family for Judah. Ekron pipol go bi my own too, just like Jebus pipol.
ZEC 9:8 Den I go surround and guide my temple both for back and front. I nor go allow wiked rulers opress my pipol again, bikos naw, I don si how my pipol sofa rish.”
ZEC 9:9 Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
ZEC 9:10 God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”
ZEC 9:11 God sey, “Bikos of di sakrifice and blood kovenant wey I make with una, I go free una pipol from slave work.
ZEC 9:12 Israel pipol wey bi prisonas, make una kom back, bikos una don get hope. Make una kom back to di place where una go for dey save. I dey tell una naw sey, ‘I go give una doubol blessing, bikos of how una don sofa.’
ZEC 9:13 I go use Judah pipol take do bow and Israel pipol go bi my arrow. Zion men go bi my swod wey I go take distroy Greece pipol.”
ZEC 9:14 God go appear on-top en pipol; E go shot en arrow like tonda lite. God wey get pawa go blow di trumpet; E go mash kom from sout under one heavy rain.
ZEC 9:15 Oga God wey get pawa go protet en pipol and dem go distroy dia enemies. Dem go dey shaut for war like who drink dey katch and dem go kill dia enemies finish. Dia enemies blood go plenty well-well like sakrifice blood wey dem pour put for di altar.
ZEC 9:16 Wen dat day rish, just as shepad dey save en animals from danger, na so too Oga God go save en pipol. Dem go shine for en land like crown wey dem make with gold.
ZEC 9:17 Dem go dey good and fine well-well! Di korn and wine wey di yong pipol go dey chop and drink, go make dem grow and dey strong.
ZEC 10:1 Make una ask God for rain wen rainin sizin rish, bikos na God dey give rain wey dey make evritin wey pipol plant, grow.
ZEC 10:2 Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.
ZEC 10:3 God sey, “Bikos I dey vex for doz strenjas wey dey rule my pipol, I go ponish dem well-well. Judah pipol na my own and mi wey bi di God wey dey mighty go kare for dem. Dem go bi my strong shariot.
ZEC 10:4 Rulers, leaders and kommanders go kom from Judah and some go rule my pipol.
ZEC 10:5 Judah pipol go win and mash dia enemies for portor-portor. Wen dem go fight, dem go win dia enemies, bikos mi God dey with dem.
ZEC 10:6 “I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers.
ZEC 10:7 Israel pipol go bi like strong sojas and dem go happy like pipol wey drink wine. Dia shidren go remember as dem take win kon happy, bikos of wetin God don do.
ZEC 10:8 I go koll and gada my pipol togeda. I go save dem and dem go many pass as dem bi before.
ZEC 10:9 Even doh I skata dem go oda nashons, dem go remember mi for anywhere wey dem dey. Dem with dia shidren wey survive, go kom back to Israel land.
ZEC 10:10 I go bring dem kom back from Egypt and Assyria kon make dem stay dia own kountry again. I go still make dem stay for Gilead and Lebanon and dia pipol go full di whole land.
ZEC 10:11 Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.
ZEC 10:12 I go make my pipol strong and dem go woship and obey mi.”
ZEC 11:1 Lebanon, make yu open yor gate, so dat fire go burn yor cedar tree rish groun!
ZEC 11:2 Cypress, make yu kry take body nak groun, bikos di cedar trees don die and doz fine-fine trees don dey yuzles! Bashan oak trees, make una kry take body nak groun, bikos dem don kut una for groun!
ZEC 11:3 Make una si as doz wey dey lead di pipol dey kry, bikos dia glory don vanish! Make una listin as lions dey shaut, bikos dem don distroy di bush where dem dey stay, near Jordan River!
ZEC 11:4 Di Oga my God tell mi, “Make yu bihave like shepad wey dem won go kill all en sheep.
ZEC 11:5 Wen who get sheep kill en sheep, anybody go ponish am? E go sell di meat finish kon sey, ‘Make wi praiz God wey don give us plenty money!’ So who even get sheep, nor dey sorry for dem.”
ZEC 11:6 So God sey, “I nor go sorry for anybody for dis land again. Na mi mysef go put all di pipol under dia ruler pawa. Di ruler go distroy di eart and I nor go save pipol from en pawa.”
ZEC 11:7 Na pipol wey dey buy and sell di sheep, hire mi and I kon turn shepad wey dem won go kill en sheep. I take two stik kon koll one, “Favor” and di oda one na, “Unity.” So I kon dey kare for di sheep dem.
ZEC 11:8 Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too.
ZEC 11:9 Den I tell di sheep sey, “I nor go bi una shepad again. So doz wey won die, make dem die and doz wey dem go distroy, make dem distroy dem. Doz wey remain, go distroy each oda.”
ZEC 11:10 So I take di stik wey dem dey koll “Favor” kon break am take kansol di kovenant wey God make with di pipol.
ZEC 11:11 I kansol di kovenant dat same day. Di pipol wey dey buy and sell di sheep dey look mi and dem know sey God gri with evritin wey I dey do.
ZEC 11:12 So I tell dem, “If una wont, make una give mi my money, but una fit keep di money if una like am like dat.” So dem pay mi thirty silva.
ZEC 11:13 God kon tell mi, “Make yu put dem for di temple pus.” So I take di thirty silva, di money wey dem feel sey dem fit take buy mi kon put am for di temple pus.
ZEC 11:14 I break di sekond stik wey bi “Unity” and di unity wey dey among Judah and Israel pipol kon skata.
ZEC 11:15 Den God tell mi, “Make yu bihave like sey yu bi shepad again. Dis time, yu go bihave like yuzles profet.
ZEC 11:16 Even doh I put shepad make e kare for my sheep, e nor go fit do anytin wen odas dey treaten to distroy di sheep. E nor kare about di ones wey lost or wound or to even feed di odas. Instead, e dey kill di betta ones chop kon trowey di rest part for bush.
ZEC 11:17 “Doz wiked shepad go die finish! Dem don leave dia sheep. Dem nor go get pawa again; dem nor go fit karry dia hand take fight and dia eyes go blind.”
ZEC 12:1 Dis na God message about Israel. Na God kreate di sky and di eart kon give life to man. God sey,
ZEC 12:2 “I go make Jerusalem bi like cup wey wine full and all di kountries near am go drink from am kon dey stagga like drunkard man. And wen dem won attack Jerusalem, dem go attack all di town for Judah too.
ZEC 12:3 But wen dat time rish, I go make Jerusalem bi like rock wey nobody fit move and all di nashons go gada togeda kon try to move am, but dem go just dey wound diasef.”
ZEC 12:4 Oga God sey, “For dat time, I go make all di horse dey fear and di pipol wey dey ride dem nor go know wetin dem dey do. I go guide Judah pipol kon blind dia enemies horse eye.
ZEC 12:5 Den Judah leaders go tell demsef, ‘Jerusalem pipol dey strong well-well bikos na di Oga wey get pawa bi dia God.’
ZEC 12:6 For dat day, I go make Judah leaders bi like fire wey dey burn forest and farm wey ripe korn full. Dem go distroy all di nashons wey surround dem, den Jerusalem pipol go dey save.
ZEC 12:7 Mi wey bi God go first save Judah, so dat David shidren-shidren and Jerusalem pipol honor, nor go big pass Judah pipol own.
ZEC 12:8 For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.
ZEC 12:9 For dat time, I go distroy all di nashons wey try to attack Jerusalem.
ZEC 12:10 “Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.
ZEC 12:11 For dat time, di kry for Jerusalem go heavy pass Hadad-Rimmon wey dey near Megiddo own.
ZEC 12:12 Di land go mourn. Each family go mourn by demsef. Di family wey kom from David tribe, Natan tribe,
ZEC 12:13 Levi tribe; Shimei tribe and all di oda family, go kry well-well.
ZEC 12:14 Each family go mourn well-well. Men go dey kry dia own, while dia wife sef, go dey kry dia own too.”
ZEC 13:1 God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
ZEC 13:2 For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.
ZEC 13:3 But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
ZEC 13:4 “For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol.
ZEC 13:5 Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’
ZEC 13:6 Den if pesin ask am, ‘So na who wound yu for yor chest?’ E go ansa, ‘Na my friend house I for wound.’ ”
ZEC 13:7 God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol
ZEC 13:8 and if dem divide all di pipol wey dey di land into three, two part go die finish.
ZEC 13:9 I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”
ZEC 14:1 Di day wen God go judge en pipol don near. Den, dem go tif all di propaty wey dey Jerusalem kon divide di tins wey dem tif for una present.
ZEC 14:2 God go gada all di nashons go fight Jerusalem. Dem go attack di town, tif evritin from all di house, den rape di wimen. Dem go karry some of di pipol go anoda land as slave, but dem nor go take evribody komot from di town.
ZEC 14:3 Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.
ZEC 14:4 For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.
ZEC 14:5 Una go from dis valley go di mountin kon eskape go di oda side. Una go run, just as una grand-grand papa dem do wen groun open for di time wen Uzzaya bi king for Judah. Den all di angels go follow Oga God wen E dey kom.
ZEC 14:6 For dat day, lite nor go shine again; di place wey dey bring lite from heaven, go stop.
ZEC 14:7 But e go happen for one special day and na only Oga God know di day. Normal day and nite go dey and even wen evening rish, lite go still dey shine like day time.
ZEC 14:8 For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.
ZEC 14:9 Den God go bi king for all di eart; evribody go woship and know am as God.
ZEC 14:10 All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.
ZEC 14:11 Di pipol go stay and dey save for der and bad tin nor go happen to dem again.
ZEC 14:12 God go bring wiked diziz kom all di nashons wey fight against Jerusalem. Dia flesh go dey rotin even wen dem still dey alive; even dia eyes and tongue go rotin too.
ZEC 14:13 For dat day, God go konfuse dem well-well and fear go katch dem, sotey dem go bigin seize and attack demsef.
ZEC 14:14 Judah men sef go dey fight and defend Jerusalem. Dem go take all di oda nashons propaty plus dia gold, silva and all dia many klot.
ZEC 14:15 Wiked diziz go katch all di horse, melu, kamel, donkey and di oda animals wey dey di enemies kamp.
ZEC 14:16 Den all di pipol wey survive for di nashons wey attack Jerusalem go dey go der evry year go woship Oga God wey dey mighty and wey bi king and dem go still join celebrate Shelta Feast.
ZEC 14:17 If any nashon nor gri go woship Oga God wey bi King, wey dey lead heaven sojas, rain nor go fall for dia land.
ZEC 14:18 If Egypt pipol nor gri celebrate Shelta Feast, di same diziz wey God send go all di nashons wey nor gri celebrate di feast, go katch dem too.
ZEC 14:19 If Egypt pipol and all di oda nashons nor gri celebrate di Shelta Feast, all dis ponishment go follow dem.
ZEC 14:20 For dat day, dem go rite sey, “Na Oga God Dey holy.” Di pot wey dey God temple go dey holy, just as di basin wey dey di altar front.
ZEC 14:21 Di pots wey dem take dey kook for Jerusalem and Judah go dey holy before di Oga awa God wey get pawa, so dat doz wey dey kom offa sakrifice, go use dem take kook dia sakrifice. For dat day, di pipol from Kanaan wey dey sell inside Oga God Temple, nor go ever dey for awa God house again.
MAL 1:1 Dis na di message wey God give Malakai about Israel pipol.
MAL 1:2 God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?” God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob
MAL 1:3 kon rijet Esau, en broda. I distroy Esau hill kountry kon turn dia land to where dem dey trowey dirty put and naw, na wild animals dey stay der.”
MAL 1:4 Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”
MAL 1:5 Wen una si all dis tins dey happen, una go sey, “God pawa big well-well both for Israel land and for evriwhere for di world!”
MAL 1:6 Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’
MAL 1:7 Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all.
MAL 1:8 Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am.
MAL 1:9 So, make una beg God, so dat E go favor una. But with dis kind sakrifice wey una dey bring, how E won take ansa una prayers?”
MAL 1:10 God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
MAL 1:11 God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.
MAL 1:12 But una nor dey respet mi, bikos una sey e dey okay to spoil God altar, so una dey give mi sakrifice wey unasef nor go asept.
MAL 1:13 Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una?
MAL 1:14 Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”
MAL 2:1 Oga God tell di priests, “Dis kommand na for una:
MAL 2:2 Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
MAL 2:3 I go ponish una shidren-shidren and di animals wey una dey sakrifice, I go rub una face for dia shit and dem go karry una komot for my present.
MAL 2:4 Den, una go know sey na mi give una dis kommandment, so dat di kovenant wey I make with Levi shidren wey bi my priests, go kontinue.
MAL 2:5 Di rizin why I make kovenant with dem, na to give dem life and peace and dat na wetin I give dem, so dat dem go respet mi and dat time, dem really respet and fear mi.
MAL 2:6 Instead of dem to dey tink bad tins, dem dey tink about wetin dey good and peace dey between us, bikos dem nor only dey do wetin dey good, but dem help many pipol, stop to sin.
MAL 2:7 Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.
MAL 2:8 But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una.
MAL 2:9 So, I go make di pipol hate una well-well, bikos una nor dey do wetin I tell una and wen una dey tish my pipol, una nor dey trit evribody ekwol.”
MAL 2:10 Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?
MAL 2:11 Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.
MAL 2:12 Doz wey do dis kind tin, make God wey get pawa remove dem komot from Israel kommunity and make E nor ever let dem join again for di sakrifice wey awa pipol dey bring kom gi-am.
MAL 2:13 Dis na anoda tin wey una dey do: Una go kry until una tear go full God altar, bikos E nor asept di sakrifice wey una bring kon gi-am.
MAL 2:14 Una dey ask, “Why E nor gri asept awa sakrifice again?” Na bikos E know sey una don break di promise wey una make with di wife wey una marry wen una yong. Na una patina e bi, but naw, una don break di promise, even doh una promise for God present sey una go dey faithful to am.
MAL 2:15 God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.
MAL 2:16 Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”
MAL 2:17 Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”
MAL 3:1 “Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.
MAL 3:2 But who go fit bear di day wen E go kom? Who go fit survive wen E go appear? Bikos E go bi like strong soap wey dey spoil klot and like fire wey dey melt iron.
MAL 3:3 E go kom judge like pesin wey dey wosh and klean silva and gold. Just as pesin wey dey wosh gold and silva so dat dem go klean, na so too, God messenja go wosh di priests, so dat dem go bring betta sakrifice kom give God.
MAL 3:4 Den God go happy with di kind sakrifice wey Judah and Jerusalem pipol go bring kom gi-am, just as E dey happy with dem before.”
MAL 3:5 Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.
MAL 3:6 “Na mi bi God and I nor dey shange. Una wey bi Jakob shidren, na mi make una neva die finish.
MAL 3:7 Na from una grand-grand papa time, una don turn komot from my law and nor gri obey mi. Make una turn back kom meet mi and I go turn kom meet una. But una dey ask, ‘How wi won take turn kom meet Yu wen wi neva leave Yu before?’
MAL 3:8 E dey good for pesin to shit God? No! But una dey shit mi and una dey ask, ‘How wi take dey shit Yu?’ Na for di matter wey koncern una ofrin and one out of evry ten tins wey una get.
MAL 3:9 Curse dey una head, bikos na di whole nashon dey shit mi.
MAL 3:10 “Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.
MAL 3:11 I nor go let ant distroy wetin una plant and grapes go full una gardin.
MAL 3:12 Den di pipol for di nashons go koll una, ‘Happiness’, bikos una land go bi betta place for pipol to stay.”
MAL 3:13 God sey, “Una don tok bad-bad tins against mi. But una dey ask, ‘Wetin wi tok?’
MAL 3:14 Una sey, ‘E nor get wetin pesin go gain if e serve God. Wetin bi di nid to do wetin E tok or try to show Oga God sey wi dey sorry for wetin wi do?’
MAL 3:15 Naw, wi dey sey, na pipol wey dey karry body up, happy pass. Wiked pipol nor dey only prosper, but dem dey test as God patient bi with di wiked tins wey dem dey do; yet nor-tin dey happen to dem.”
MAL 3:16 Den di pipol wey dey fear God kon tok to each oda and God listin and hear wetin dem tok. For God present, all doz wey dey fear and respet en name, dem kon rite dia name put for one book so dat God go remember dem.
MAL 3:17 Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.
MAL 3:18 Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”
MAL 4:1 Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.
MAL 4:2 But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.
MAL 4:3 Den for di day wen I go do all dis tins, una go mash wiked pipol for groun and dem go bi like ashes under una leg.”
MAL 4:4 “Make una remember to obey my savant, Moses Law and all di kommandments wey I gi-am for Mount Sinai sey make e tell Israel pipol.
MAL 4:5 Make una si, I go send Profet Elijah kom meet una, before God Judgement Day go kom.
MAL 4:6 Wetin e go prish, go make papa setol with dia shidren and shidren go setol with dia papa. If not, I go kom skata and distroy di land.”
MAT 1:1 Jesus Christ wey dem born for David and Abraham family, naim story bi dis.
MAT 1:2 Abraham born Isaak, Isaak kon born Jakob. Na Jakob born Judah and en brodas,
MAT 1:3 Judah born Perez and Zera (wey en mama bi Tamar), Perez born Hezron and Hezron born Ram,
MAT 1:4 Ram na Amminadab papa, Amminadab born Nashon, Nashon kon born Salmon,
MAT 1:5 Salmon born Boaz (wey Rahab bi en mama), na Boaz bi Obed papa (wey Rut bi en mama), Obed kon born Jesse,
MAT 1:6 Jesse born David wey bi Israel pipol king. David born Solomon (wey Uraya wife bi en mama),
MAT 1:7 Solomon born Rehoboam, Rehoboam naim bi Abijah papa and Abijah kon born Asa,
MAT 1:8 Asa born Jehoshafat, Jehoshafat kon born Joram, Joram born Uzzaya,
MAT 1:9 Uzzaya born Jotam, Jotam kon born Ahaz, wey born Hezekaya,
MAT 1:10 Hezekaya born Manasseh, Manasseh naim bi Amnon papa and na Amon born Josaya.
MAT 1:11 Josaya born Jekonaya and en brodas for di time wey dem karry Israel pipol go bi slave for Babilon.
MAT 1:12 Afta dem karry Israel pipol go Babilon, Jekonaya kon born Shealtiel, Shealtiel kon bi Zerubabel papa,
MAT 1:13 Zerubabel born Abiud, Abiud naim bi Eliakim papa, Eliakim kon born Azor,
MAT 1:14 Azor born Zadok, Zadok naim bi Akim papa, Akim kon born Eliud,
MAT 1:15 Eliud born Eleazar wey bi Matan papa, Matan kon born Jakob,
MAT 1:16 Jakob born Josef wey bi Mary husband, dis Mary naim bi Jesus Christ mama.
MAT 1:17 So, from Abraham go rish David time, na fourteen generashon dey and from David time go rish wen dem karry Israel pipol go Babilon, na fourteen too and from dat time go rish wen dem born Jesus Christ, na fourteen generashon e bi.
MAT 1:18 Dis na how dem take born Jesus Christ. Wen Mary en mama don ready to marry Josef, before dem bigin sleep togeda, Mary kon si sey e don get belle with Holy Spirit pawa.
MAT 1:19 Josef wey won marry am, na pesin wey dey fear God well-well and bikos e nor won disgrace am, e kon tink for en mind sey e nor go marry Mary again.
MAT 1:20 As e dey tink how e go take leave am, God angel show ensef to am for dream kon tell am sey, “Josef, David pikin, make yu nor fear to marry Mary, bikos di pikin wey dey en belle, na Holy Spirit gi-am.
MAT 1:21 E go born boy and yu go koll am ‘Jesus,’ bikos e go save en pipol from dia sin.”
MAT 1:22 Dis tins go happen as God profet tok:
MAT 1:23 “Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”
MAT 1:24 Wen Josef wake-up, e do wetin God angel tell am. So, e kon marry Mary,
MAT 1:25 but e nor sleep with am until Mary born di pikin. Den e kon name am, Jesus.
MAT 2:1 Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea, for di time wey Herod bi king, some wise men from east kon go Jerusalem
MAT 2:2 dey ask, “Where di Jew king wey dem just born? Wi si di star wey tok about am, so wi kom woship am.”
MAT 2:3 Wetin dem tok so, vex King Herod and Jerusalem pipol.
MAT 2:4 So, di king gada all di priest oga dem and di pipol wey sabi di law kon ask dem, “Where una tink sey dem go for born Christ?”
MAT 2:5 Dem kon ansa, “Na for Betlehem, wey dey Judea, just as Profet Isaya rite sey:
MAT 2:6 “ ‘Betlehem pipol, una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah, na from among una di pesin wey go lead all my pipol for Israel, go from kom.’ ”
MAT 2:7 Den Herod koll di wise men go korna, make dem for tell am wen dem si di star.
MAT 2:8 E kon sey, “Make una go look for di pikin well-well. Wen una don si am, make una kom tell mi, so dat mi too, go-go woship am.”
MAT 2:9 Wen di king tok finish, di wise men kon dey go and di star wey dem si before, kon dey lead dem until e stop on-top di house where di pikin dey.
MAT 2:10 Wen dem si di star, dem kon dey happy.
MAT 2:11 Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.
MAT 2:12 Bikos God warn dem for dream make dem nor go back go meet Herod, dem kon pass anoda road go dia house.
MAT 2:13 Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”
MAT 2:14 Dat same nite, Josef wake-up, karry di pikin and en mama kon run go Egypt.
MAT 2:15 Dem stay der till Herod die. Dis tin make wetin God profet tok happen sey, “I koll my pikin komot from Egypt.”
MAT 2:16 Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
MAT 2:17 Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey,
MAT 2:18 “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit make en heart strong.”
MAT 2:19 Afta Herod die, God angel appear to Josef for dream wen e still dey Egypt,
MAT 2:20 kon tell am, “Make yu get up, karry di pikin and en mama go Israel, bikos di pesin wey won kill-am, don die.”
MAT 2:21 So, e karry di pikin and en mama go Israel back.
MAT 2:22 But wen e hear sey Arkelaus dey rule for Judea, afta Herod en papa don die, Josef kon fear to go der. Afta God don warn am for dream, e kon go Galilee.
MAT 2:23 Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”
MAT 3:1 For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey,
MAT 3:2 “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.”
MAT 3:3 Na dis John Profet Isaya tok about sey, “One pesin dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make God road strait.’ ”
MAT 3:4 John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop.
MAT 3:5 Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am
MAT 3:6 and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.
MAT 3:7 But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
MAT 3:8 Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God,
MAT 3:9 make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren!
MAT 3:10 Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.
MAT 3:11 “I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
MAT 3:12 Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
MAT 3:13 Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River.
MAT 3:14 But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”
MAT 3:15 Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
MAT 3:16 As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.
MAT 3:17 Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
MAT 4:1 Di Holy Spirit take Jesus go inside wildaness make devil for tempt am.
MAT 4:2 Afta Jesus don fast for forty days and forty nites, e kon dey hongry.
MAT 4:3 Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”
MAT 4:4 Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man go take survive, but na with evry word wey God tok.’ ”
MAT 4:5 Den, devil show Jesus di holy town kon make am stand on-top di place wey high pass for di temple
MAT 4:6 and e tell Jesus, “If yu really bi God pikin, jump go down, bikos dem rite for God word sey, “ ‘God go kommand en angels make dem do evritin for yu and dem go katch yu make yor leg nor nak stone.’ ”
MAT 4:7 Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor try God wey bi yor Oga God.’ ”
MAT 4:8 Den devil take Jesus go one mountin wey high well-well kon show am all di kingdom for dis world and all di betta tins inside am.
MAT 4:9 Devil kon tell am, “I go give yu all dis tins, if yu go bow down woship mi.”
MAT 4:10 Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”
MAT 4:11 So, devil kon leave Jesus and God angels kon bigin help am.
MAT 4:12 Wen Jesus hear sey dem don put John inside prison, e kon go back to Galilee.
MAT 4:13 From der, Jesus komot from Nazaret go Kapanaum wey near di sea, where Zebulun and Naftali pipol dey stay,
MAT 4:14 so dat wetin Profet Isaya tok, go happen:
MAT 4:15 “Zebulun and Naftali di place where river for cross Jordan River go Galilee, where pipol wey nor bi Jew dey stay,
MAT 4:16 una wey dey darkness, don si big lite and una wey don nearly die, don get life.”
MAT 4:17 From dat time, Jesus bigin prish sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don kom meet una.”
MAT 4:18 As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e si two brodas, Simon wey dem dey koll Pita and Andru en broda, dem dey trow net inside di river dey katch fish.
MAT 4:19 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go make una katch pipol.”
MAT 4:20 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
MAT 4:21 As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas.
MAT 4:22 Kwik-kwik dem run leave dia papa inside di boat, kon follow Jesus.
MAT 4:23 Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.
MAT 4:24 So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
MAT 4:25 Many pipol from Galilee, Dekapolis, Jerusalem, Judea and pipol wey dey stay near Jordan River, kon follow am.
MAT 5:1 Wen Jesus si di pipol, e klimb go di mountin and en disciples follow am. Afta e don sidan,
MAT 5:2 e kon bigin tish dem sey;
MAT 5:3 “God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get heaven.
MAT 5:4 God go bless una wey dey mourn, bikos E go make una happy.
MAT 5:5 God go bless una wey nor dey karry body up, una go enjoy en promise for dis world.
MAT 5:6 God go bless una wey dey like to do good tins, E go give una evritin wey una wont.
MAT 5:7 God go bless una wey dey sorry for pipol, una go receive mesi.
MAT 5:8 God go bless una wey get pure heart, na una go si God.
MAT 5:9 God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.
MAT 5:10 God go bless una wey dey sofa bikos una dey do wetin dey rite, na una go enjoy God Kingdom for heaven.
MAT 5:11 “God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi,
MAT 5:12 make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
MAT 5:13 “Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
MAT 5:14 “Na una bi lite for dis world and town wey dey on-top mountin, nor dey hide.
MAT 5:15 Pesin nor dey lite lamp kon kover am with basin, instead e go put am for where evribody wey dey inside di house go si am.
MAT 5:16 Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
MAT 5:17 “Make una nor tink sey I kom spoil Moses Law and di tins wey di profets tish. Nor bi so, misef kom obey dem.
MAT 5:18 I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen.
MAT 5:19 So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.
MAT 5:20 I tell yu di trut, if di good wey yu do, nor betta pass wetin di Farisee and di pipol wey dey tish di Law do, yu nor go fit enter God Kingdom.”
MAT 5:21 “Yu hear as God tell awa papa dem before-before sey, ‘Nor kill and anybody wey kill, God go judge am.’
MAT 5:22 But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
MAT 5:23 “If yu take gift go altar and yu kon remember sey yor broda get bad belle for yu,
MAT 5:24 make yu leave di gift for di altar, first go setol with yor broda, den yu go fit kom back kon give yor gift.
MAT 5:25 “Kwik setol with who dey akuiz yu before una rish kourt, if not, e go give yu to di judge and di warda go trow yu inside prison.
MAT 5:26 I tell una di trut, yu nor go komot from dat trobol until yu pay all di money!”
MAT 5:27 “Yu hear wey pipol sey, ‘Make yu nor sleep with who yu nor marry.’
MAT 5:28 But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’
MAT 5:29 If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.
MAT 5:30 If yor rite hand go make yu do bad tin, make yu kut am trowey! E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.”
MAT 5:31 “Pipol dey sey, ‘Anybody wey drive en wife, must gi-am paper sey e nor won marry am again.’
MAT 5:32 But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”
MAT 5:33 “Again, yu don hear sey dem tell pipol before-before sey, ‘Make yu nor break yor promise, but do wetin yu promise God.’
MAT 5:34 But I dey tell una naw sey, make una nor ever use heaven swear at-all, bikos na God throne e bi,
MAT 5:35 or with eart, bikos naim God dey put en leg, or use Jerusalem, bikos na di big king town
MAT 5:36 Nor even take yor head swear, bikos yu nor fit make one singol hair white or black.
MAT 5:37 Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”
MAT 5:38 “Una hear sey, ‘Anytin anybody do una, make una do am back.’
MAT 5:39 But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.
MAT 5:40 If anybody drag yor shirt with yu, make yu gi-am yor koat join.
MAT 5:41 And if anybody force yu waka one mile, make yu follow am waka two mile.
MAT 5:42 Give pipol anytin wey dem ask from yu and nor drive anybody wey kom borrow sometin from yu.”
MAT 5:43 “Una hear sey, ‘Make una love una neighbour and hate una enemy.’
MAT 5:44 But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,
MAT 5:45 so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.
MAT 5:46 If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so?
MAT 5:47 If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?
MAT 5:48 So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”
MAT 6:1 “Make una nor dey do good bikos una wont make pipol si una; if una do so, God nor go pay una for di good wey una do.
MAT 6:2 “Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
MAT 6:3 But wen una dey give, make una nor let una left hand know wetin una rite hand give.
MAT 6:4 So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
MAT 6:5 “Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
MAT 6:6 But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
MAT 6:7 Wen una dey pray, make una nor tok one word many times as pipol wey dey serve juju dey do, bikos dem tink sey dia juju go hear dem wen dia tok plenty.
MAT 6:8 Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.
MAT 6:9 “So make una pray like dis: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi praiz yor name,
MAT 6:10 make yor Kingdom kom, make wetin yu wont, happen for dis world as e bi for heaven.
MAT 6:11 Give us di food wey wi go chop evriday,
MAT 6:12 forgive us all di bad-bad tins wey wi don do, as wisef dey forgive odas di bad tins wey dem do us.
MAT 6:13 Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’
MAT 6:14 If una forgive oda pipol di bad tins wey dem do una, una Papa wey dey for heaven go forgive una too.
MAT 6:15 But if una nor forgive odas, una Papa sef nor go forgive una.”
MAT 6:16 “Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
MAT 6:17 But wen una dey fast, make una wosh and rub pomade for una face,
MAT 6:18 so dat odas nor go know sey una dey fast, but only una Papa wey dey for sekret go know. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
MAT 6:19 “Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem.
MAT 6:20 But make una gada betta tins for unasef for heaven, where siti-siti nor go for fit chop dem and dem nor go rust and tif nor go fit enter tif dem,
MAT 6:21 bikos, where una propaty dey, na der una heart go dey too.
MAT 6:22 “Na eye bi di lite for pesin body. If pesin eye dey okay, lite go full en body.
MAT 6:23 But if pesin eye blind, den darkness go full en body. If di lite wey dey inside una na darkness, di darkness big well-well!
MAT 6:24 “Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
MAT 6:25 “So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
MAT 6:26 Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?
MAT 6:27 Who among una wey dey worry go fit add one hour join en life?
MAT 6:28 “Why una dey worry about klot wey una go wear? Make una tink how flower dey grow for field; dem nor dey work or make klot wey dem dey wear.
MAT 6:29 I tell una true word, even Solomon, upon all di money wey e get, e nor wear klot wey fine rish di ones wey dis flower dem dey wear!
MAT 6:30 If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.
MAT 6:31 So make una nor worry kon dey sey, ‘Wetin wi go chop, drink or wear?’
MAT 6:32 Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem.
MAT 6:33 But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.
MAT 6:34 So make una nor worry about tumoro, bikos tumoro get en own wahala. Today trobol don do.”
MAT 7:1 “Make una nor dey judge pipol anyhow, so dat God nor go judge una.
MAT 7:2 Bikos as una dey judge, na so God go take judge una. And as una dey do to oda pipol, na so dem go do una too.
MAT 7:3 “Why yu dey si di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey for yor own?
MAT 7:4 How yu won take tell yor broda sey, ‘Make I remove di dirty wey dey yor eye, wen big wood dey yor own?’
MAT 7:5 Yu wey dey pritend, first remove di big wood wey dey yor eye, den yu go fit si di small dirty for yor broda own.
MAT 7:6 “Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.
MAT 7:7 “Wen yu ask for sometin, God go gi-am to yu; wen yu look for sometin, yu go si am and wen yu nok, di door go open for yu.
MAT 7:8 Anybody wey ask for sometin, go get am; anybody wey dey find sometin, go si wetin e dey find and pesin wey nok door, dem go open for am.
MAT 7:9 “E get any of una wey en pikin ask am for bread and e gi-am stone?
MAT 7:10 Or if di pikin ask for fish, yu go gi-am snake?
MAT 7:11 If yu wey bad fit give yor pikin good tin, yu tink sey God wey dey heaven nor go give betta tin to pipol wey ask am?
MAT 7:12 Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
MAT 7:13 “Make yu pass di small gate enter, bikos di gate wey pipol go pass go sofa, wide well-well and many pipol dey waka enter.
MAT 7:14 But di gate wey pipol dey pass enter life, small well-well and e hard to enter and na only few pipol go fit si am.”
MAT 7:15 “Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.
MAT 7:16 Yu go know dem with wetin dem dey do. Pipol nor dey gada grape or fig from shuku-shuku.
MAT 7:17 So too, evry good tree go bear good fruit, but bad tree, go bear bad fruit.
MAT 7:18 Good tree nor go fit bear bad fruit and bad tree nor go fit bear good fruit.
MAT 7:19 Any tree wey nor bear good fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.
MAT 7:20 So, yu go know di lie-lie profets with wetin dem dey do.”
MAT 7:21 “Nor bi evribody wey dey koll God, ‘Oga God, Oga God’, go enter God Kingdom, but na only di pipol wey dey do wetin my Papa for heaven wont.
MAT 7:22 For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’
MAT 7:23 Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”
MAT 7:24 “Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.
MAT 7:25 Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, e nor go fall, bikos dem build am on-top rock.
MAT 7:26 But pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like foolish man wey build en house on-top san.
MAT 7:27 Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, na wons e go fall skata for groun.”
MAT 7:28 Afta Jesus don tok all dis tins, di pipol sopraiz for di wey e dey tish,
MAT 7:29 bikos e tish dem like pesin wey get authority and nor bi as dia law tishas dey do.
MAT 8:1 Afta Jesus kom down from di mountin, plenty pipol kon follow am.
MAT 8:2 One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
MAT 8:3 Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body.
MAT 8:4 Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
MAT 8:5 Wen Jesus enter Kapanaum, one Roman offisa kon meet am dey beg make e help am.
MAT 8:6 Di offisa sey, “Oga God, my savant nor well for house, e nor fit get up and body dey pain am well-well.”
MAT 8:7 Jesus kon ansa, “I go kom heal am.”
MAT 8:8 But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.
MAT 8:9 Misef, I bi man wey get oga and I still get sojas wey dey under mi. If I kommand one sey make e ‘Go’, e go-go, if I kommand anoda one sey make e ‘Kom’, e go kom and if I kommand my savant make e ‘Do dis tin’, e go do am.”
MAT 8:10 Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!
MAT 8:11 Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom.
MAT 8:12 But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”
MAT 8:13 Den Jesus tell di offisa, “Go, since yu bilive, na so e go bi for yu.” Na dat same time di savant well.
MAT 8:14 Wen Jesus enter Pita house, e kon si sey Pita wife mama nor well.
MAT 8:15 Den e tosh di woman and di fever komot from en body. So, di woman get up kon bigin serve dem.
MAT 8:16 Wen evening rish, dem karry many pipol wey demon dey inside dem kom meet Jesus. E drive di wiked spirits komot kon heal all di pipol wey nor well.
MAT 8:17 Dis one make wetin Profet Isaya tok bi true, “E remove awa sickness and karry awa diziz komot.”
MAT 8:18 Wen Jesus si plenty pipol gada am, e kon kommand en disciples make dem cross go di oda side for di river.
MAT 8:19 One law tish kon tell Jesus, “Tisha, I go follow yu go anywhere wey yu dey go.”
MAT 8:20 Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”
MAT 8:21 Anoda disciple kon sey, “Oga God, make I first go beri my papa.”
MAT 8:22 Jesus ansa am, “Follow mi, make doz wey don die beri dia dead body.”
MAT 8:23 As Jesus enter di boat, en disciples kon follow am.
MAT 8:24 At wons, strong breeze kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. But Jesus Christ dey sleep.
MAT 8:25 So en disciples wake am kon sey, “Oga God, save us! Na die wi dey so o-o!”
MAT 8:26 Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.
MAT 8:27 Di men sopraiz well-well kon dey ask each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wave dey obey am!”
MAT 8:28 Wen Jesus rish di oda side where Gadarenes pipol dey stay, two men wey get demon, run from di beri groun kom meet am. Nobody dey fit pass dat road, bikos di men wiked well-well.
MAT 8:29 Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”
MAT 8:30 For where dem dey, plenty pig dey chop near der.
MAT 8:31 Den di demons beg Jesus, “If yu drive us komot, make yu send us go enter inside di pigs.”
MAT 8:32 So Jesus tell dem, “Make una go!” At wons, dem kon komot enter inside di pigs and all di pigs rush go enter di river kon die.
MAT 8:33 Di pipol wey dey look di pigs, run go di town kon tell pipol evritin wey happen to di men wey get demons.
MAT 8:34 Den evribody for di town kon dey find Jesus. Wen dem si am, dem kon beg am make e komot from dia aria.
MAT 9:1 Jesus enter boat kon cross go en home-town for di oda side.
MAT 9:2 Some pipol kon bring one man wey nor fit waka kom meet am. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey nor fit waka, “My pikin, make yu nor fear! God don forgive yu all yor sins.”
MAT 9:3 Den some law tishas kon dey tok to demsef sey, “Si as dis man dey shalenge God.”
MAT 9:4 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?
MAT 9:5 Wish one eazy pass to tok, ‘I forgive yu yor sins’ or ‘Stand up make yu waka?’
MAT 9:6 But make una know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive pipol dia sins.” So e kon tell di man wey nor fit waka, “Stand up, karry yor bed, make yu dey go yor house.”
MAT 9:7 Den di man stand up kon waka go en house.
MAT 9:8 Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.
MAT 9:9 As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
MAT 9:10 As Jesus dey chop for Matiu house, many tax kollectors and sinnas follow en and en disciples dey chop too.
MAT 9:11 Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”
MAT 9:12 Wen Jesus hear wetin dem dey tok, e kon ansa dem, “Pesin wey well nor nid doctor to cure am, but na who nor well, nid am.
MAT 9:13 Make una go learn wetin dis word mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice, bikos na sinnas I kom save, nor bi good pipol.’ ”
MAT 9:14 John disciples kom meet Jesus kon ask am, “Why e bi sey wi and di Farisee pipol dey fast evritime and yor disciples nor dey fast?”
MAT 9:15 Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.
MAT 9:16 “Nobody dey take new klot pash di whole wey dey for old klot, bikos where dem pash for di old klot go tear more and di whole wey go dey der, go big pass di one wey dey before.
MAT 9:17 Nobody go pour new wine inside old wine bag, bikos di bag go burst and di wine go pour trowey, den di wine bag go tear. Na dis make dem dey put new wine inside new wine bag, so dat di wine nor go trowey and di wine bag nor go tear.”
MAT 9:18 As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.”
MAT 9:19 So Jesus and en disciples kon follow am.
MAT 9:20 One woman wey blood dey rush komot for en body for twelf years kon kom Jesus back, den e tosh en klot korna.
MAT 9:21 Bikos di woman don tink am for en mind sey, “If I go fit tosh en klot korna, I go well.”
MAT 9:22 Wen Jesus turn round si di woman, e kon tell am, “My pikin, make yu nor worry! Yor faith don make yu well.” From dat time, di woman kon well.
MAT 9:23 Wen Jesus enter di oga house, e si pipol dey play music and plenty pipol dey make nois for der too.
MAT 9:24 E kon tell dem, “Make evribody komot, di girl neva die, e just dey sleep.” Den, dem kon bigin laf am.
MAT 9:25 Afta di pipol don go outside, Jesus go whole di girl for hand and di girl kon stand up!
MAT 9:26 Pipol kon bigin tok about wetin happen for evriwhere.
MAT 9:27 As Jesus komot for der, two blind men kon follow am dey shaut, “David pikin, make yu sorry for us!”
MAT 9:28 Wen Jesus don enter di house, di two blind men kom meet am. Den e ask dem, “Una bilive sey I fit make una si?” Dem ansa, “Yes Oga God, yu fit.”
MAT 9:29 Den Jesus tosh dia eyes kon sey, “Make e happen to una as una faith strong rish.”
MAT 9:30 At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.”
MAT 9:31 But dem kon go evriwhere, bigin tok about di tin wey Jesus do for dem.
MAT 9:32 As dem komot, some pipol bring one man wey get demon and e nor fit tok, kom meet Jesus.
MAT 9:33 Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”
MAT 9:34 But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”
MAT 9:35 Jesus waka go all di town and village, dey prish di Good News about God Kingdom for dia sinagog and dey heal difren diziz and pipol wey nor well.
MAT 9:36 Wen e si how pipol plenty rish, e kon sorry for dem, bikos nobody dey to help dem and dem kon dey waka anyhow like sheep wey nor get who dey look dem.
MAT 9:37 Den e tell en disciples, “Wetin pipol go harvest plenty well-well, but di pipol wey go do di work nor plenty rish.”
MAT 9:38 So, make una pray make di Oga God wey get di farm, send pipol wey go work for en farm, kom.
MAT 10:1 Jesus koll en twelf disciples kon give dem pawa to drive demons and heal diziz and pipol wey nor well.
MAT 10:2 Dis na di twelf disciples name: Simon (wey dem dey koll Pita); Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedee pikin and en broda John,
MAT 10:3 Filip and Bartolomew; Tomas; Matiu, wey bi tax kollector; James, wey bi Afaeus pikin and Taddaeus.
MAT 10:4 Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.
MAT 10:5 Jesus send and tell dem, “Make una nor go Gentile aria go prish and make una nor enter Samaria pipol town,
MAT 10:6 but make una go meet Israel pipol, wey bi God sheep, wey lost.
MAT 10:7 As una dey go, make una prish di message sey, ‘God Kingdom don near!’
MAT 10:8 Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too.
MAT 10:9 Make una nor karry any money follow body,
MAT 10:10 or karry bag or estra dress, sandal or walkin stik, bikos di pipol wey una go meet, go give una evritin wey una wont.
MAT 10:11 “Wen una enter any town or village, make una look for pesin wey ready to receive una for en house, make una stay with am until una komot from dat town.
MAT 10:12 Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside.
MAT 10:13 And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.
MAT 10:14 If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.
MAT 10:15 I tell una true word, e go betta for Sodom and Gomorrah pipol for judgement day, pass di pipol wey dey for dat town.”
MAT 10:16 “Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
MAT 10:17 “Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog.
MAT 10:18 Bikos of mi, dem go drag una go meet rulers and kings, so dat una go tok about mi give dem and Gentile pipol.
MAT 10:19 Make una nor worry about wetin una go tok wen dem drag una go kourt, bikos God go give una wetin to tok wen dat time rish.
MAT 10:20 Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
MAT 10:21 “Broda go sell en own broda give pipol make dem kill-am and na so papa go sell en own pikin too. Shidren go fight and kill dia papa and mama.
MAT 10:22 Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am.
MAT 10:23 Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
MAT 10:24 “Nobody big pass en tisha and know savant big pass en oga.
MAT 10:25 E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
MAT 10:26 “Make una nor fear man, bikos nor-tin wey hide wey nor go kom out and know sekret wey pipol nor go know.
MAT 10:27 Wetin I tell una for darkness, make una tok am for day time and wetin I tok for una ear, make una shaut am make pipol hear.
MAT 10:28 Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.
MAT 10:29 Nor bi one penny dem dey sell two sparo bird? But no one go fall rish groun, escept God allow am.
MAT 10:30 Si! God know how many hair dey for una head.
MAT 10:31 So, make una nor fear, una betta pass many sparo.
MAT 10:32 “Anybody wey tok for publik sey en know mi, na so mi too go tok about am give my Papa for heaven.
MAT 10:33 But anybody wey deny mi for publik, misef go deny am for heaven.”
MAT 10:34 “Make una nor tink sey, I bring peace kom dis world. No! Na war I bring.
MAT 10:35 I kom make boy pikin nor gri with en papa and make girl pikin nor gri with en mama. Wife nor go gri with en husband mama
MAT 10:36 and pesin worse enemy, go bi en own family pipol.
MAT 10:37 “Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
MAT 10:38 Anybody wey nor karry en cross follow mi, nor go fit bi my disciple.
MAT 10:39 Pesin wey hold en life tait, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.”
MAT 10:40 “Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.
MAT 10:41 Anybody wey receive profet, bikos na profet e bi, go get profet reward. Pesin wey receive good pesin, bikos na good pesin e bi, go get good pesin reward.
MAT 10:42 And anybody wey give kold wota to di pesin wey small pass among my disciples, I tell una true word, e nor go ever luz en reward.”
MAT 11:1 Wen Jesus don tish en disciples finish, e kon komot from der go tish and prish for difren towns for Galilee.
MAT 11:2 Naw, wen John hear for inside prison about di tins wey Jesus dey do, e kon send en disciples go ask am:
MAT 11:3 “Na yu bi di Mezaya wey wi dey espect or make wi wait for anoda pesin?”
MAT 11:4 Jesus kon ansa dem, “Make una go tell John wetin una dey hear and si.
MAT 11:5 Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
MAT 11:6 God go bless di pesin wey nor dey vex for mi.”
MAT 11:7 As John disciples dey go, Jesus kon tell di pipol about John: “Wetin una go desert go si? Na grass wey breeze dey blow?
MAT 11:8 Who una go outside go si? Abi na man wey wear fine dress? Pipol wey dey wear fine dress like dat, nor bi king palis dem dey stay?
MAT 11:9 Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
MAT 11:10 Na John bi di pesin wey dem rite for God word about sey: “ ‘Si, I dey send pesin go yor front, make e go prepare di way for yu.’
MAT 11:11 I tell una true word, among all di pipol wey woman born, e nor get anybody wey big rish John di Baptist. But di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.
MAT 11:12 From John di Baptist time kon rish naw, pipol dey struggol to enter God Kingdom, but na only doz wey dey struggol well-well, dey fit enter.
MAT 11:13 Before John kom, Moses Law and di profets dey prish about wetin go happen.
MAT 11:14 And if una go gri with wetin I dey tok, John, na-im bi Elijah wey suppose to kom.
MAT 11:15 Anybody wey get ear, make e hear!
MAT 11:16 “Wetin I go sey dis time pipol bi like? Dem bi like shidren for market wey dey hala for each oda sey,
MAT 11:17 “ ‘Wi blow flute for una, but una nor gri dance, wi dey kry for awa pesin wey die, but una nor follow us kry.’
MAT 11:18 Wen John di Baptist kom, e nor chop, drink or enjoy life but una sey, ‘E get demon!’
MAT 11:19 But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
MAT 11:20 Jesus kon dey curse all di town where e for do many mirakles, bikos di pipol nor gri turn from sin kom meet God.
MAT 11:21 “E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,
MAT 11:22 but I tell una true word, e go eazy for Tyre and Sidon for judgement day pass una.
MAT 11:23 Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today.
MAT 11:24 But I tell una, God go get mesi for Sodom pass una for judgement day!”
MAT 11:25 For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
MAT 11:26 Yes! Papa, na so yu wont make e bi.
MAT 11:27 “My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.
MAT 11:28 Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.
MAT 11:29 Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.
MAT 11:30 My way eazy to follow and my load nor heavy to karry.”
MAT 12:1 Dat time, Jesus waka pass one korn farm for Sabat Day. En disciples kon dey plok di korn chop, bikos dem dey hongry.
MAT 12:2 But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”
MAT 12:3 Jesus ansa, “Una neva read wetin David do wen en and en pipol dey hongry,
MAT 12:4 how dem enter God house kon chop di holy bread wey ordinary pipol nor suppose chop, bikos na only priests suppose to chop am?
MAT 12:5 Or una neva read for Moses Law sey, priests dey work for Sabat Day, but nobody dey sey dem kommit sin?
MAT 12:6 I tell una, pesin wey big pass di temple dey here with una naw.
MAT 12:7 If to sey una know wetin dis tin mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice’, una nor for kondemn pesin wey nor kommit sin.
MAT 12:8 Man Pikin na-im bi Sabat Day Oga God.”
MAT 12:9 Den Jesus komot der kon enter dia sinagog.
MAT 12:10 One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
MAT 12:11 Jesus ansa, “If any of una get sheep wey fall inside pit for Sabat Day, e nor go-go karry am out?
MAT 12:12 Human being betta pass sheep! So, e dey rite to do good for Sabat Day.”
MAT 12:13 Den Jesus tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon strong like di oda one.
MAT 12:14 But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.
MAT 12:15 Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.
MAT 12:16 But e warn dem sey, make dem nor tell anybody who e bi.
MAT 12:17 Dis make wetin Profet Isaya tok, happen:
MAT 12:18 “Na my savant wey I choose bi dis, di One wey I love, wey I dey happy with. I go put my Spirit inside am and e go judge di world.
MAT 12:19 E nor go kworel or shaut, nobody go hear en vois for publik, e nor go tosh pesin wey weak,
MAT 12:20 or kwensh di small hope wey pesin get, until dem go stop to opress pipol.
MAT 12:21 And en name go give hope to Gentile and oda pipol for dis world.”
MAT 12:22 So dem kon bring one blind man wey get demon and nor fit tok, kom meet Jesus. Jesus heal am and di man kon dey si and tok.
MAT 12:23 Di pipol sopraiz well-well kon dey ask, “Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for?”
MAT 12:24 But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”
MAT 12:25 Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.
MAT 12:26 So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand?
MAT 12:27 And if na Belzibub pawa I take dey drive demons komot, na wish pawa una shidren dey take drive demon too? Bikos of dis, una shidren go judge una.
MAT 12:28 But if na God Spirit I take dey drive demons, den God Kingdom don already kom meet una.
MAT 12:29 “How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.
MAT 12:30 “Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor join mi, dey skata my work.
MAT 12:31 Naim make mi dey tell una sey, ‘God go forgive pipol dia sin and all di bad word wey dem tok, but anybody wey curse or tok bad word against di Holy Spirit, God nor go forgi-am.’
MAT 12:32 Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
MAT 12:33 “Good tree dey bear good fruit and bad tree dey bear bad fruit. Na di fruit wey tree bear, naim pipol take dey know di kind tree wey e bi.
MAT 12:34 Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.
MAT 12:35 As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.
MAT 12:36 I tell una true word, for judgement day, pipol go ansa God for all di yeye word wey dem tok.
MAT 12:37 Na di word wey yu dey tok, naim go fit free or kondemn yu for God present.”
MAT 12:38 Some of dem wey bi law tisha and Farisee pipol kon tell Jesus, “Tisha, wi wont make yu show us sign.”
MAT 12:39 Jesus ansa, “Si dis bad and wiked pipol for dis time wey dey ask for sign, I nor go show una any sign, escept Profet Jonah own.
MAT 12:40 As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.
MAT 12:41 For judgement day, Nineveh pipol go kondemn di pipol for dis time, bikos wen Jonah prish give dem, dem turn from sin kom meet God. And naw, somebody wey big pass Jonah dey here with una!
MAT 12:42 For judgement day, Sheba kween go kondemn di pipol for dis time, bikos e travel from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, somebody wey big pass Solomon dey here with una!”
MAT 12:43 “Wen evil spirit don komot from pesin body, e dey pass where wota nor dey, dey find where e go rest, but if e nor si,
MAT 12:44 e go tell ensef, ‘I go-go back to di house where I from komot.’ Wen e kom back kon si sey di house empty and dem don swip and arrange am,
MAT 12:45 e go-go bring seven spirit wey wiked pass am, kom. Dem go enter di pesin kon sidan for der, so di pesin kondishon go kon bad pass as e bi before. Na like dis e go happen to evil pipol for dis time.”
MAT 12:46 As Jesus still dey tok, en mama and brodas kon stand for outside, bikos dem won si am.
MAT 12:47 So somebody for der kon tell Jesus, “Si, yor mama and brodas dey outside and dem won tok to yu.”
MAT 12:48 Jesus kon ask di pesin, “Who bi my mama and brodas?”
MAT 12:49 Den Jesus point to en disciples kon sey, “Na dis pipol bi my mama and brodas.
MAT 12:50 Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”
MAT 13:1 Dat same day, Jesus komot from di house go sidan for Galilee wotaside.
MAT 13:2 Many pipol gada round am, so e enter one boat and all di pipol sidan for groun near di wota.
MAT 13:3 E kon use parabol tish dem many tins: “Si! E get one farmer wey go plant seed for en farm.
MAT 13:4 As e dey plant, some seed fall for road and bird kon chop dem.
MAT 13:5 Some fall for san wey get big-big stone. Di one wey fall for san, kwik grow bikos di san nor deep.
MAT 13:6 So wen sun kom out, e burn dem and bikos dia rut nor deep well, dem kon die.
MAT 13:7 Some seed fall for shuku-shuku. Dem grow kom out, but di shuku-shuku, shuk dem die.
MAT 13:8 But some seed fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish hundred, some sixty and some thirty.
MAT 13:9 Anybody wey get ear, make e hear!”
MAT 13:10 Den di disciples kom meet Jesus ask am, “Why yu dey tok to dis pipol with parabol?”
MAT 13:11 Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.
MAT 13:12 Pesin wey get sometin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenty. But pesin wey nor get anytin, even di small one wey e get, dem go take am from am.
MAT 13:13 Naim make I dey tok with parabol sey: “ ‘Dis pipol get eye, but dem nor dey si, dem get ear, but dem nor dey hear or undastand.’
MAT 13:14 Na dis tin make wetin Profet Isaya tok happen, ‘Una go listin well-well, but una nor go undastand. Una go look well-well, but una nor go si anytin,
MAT 13:15 Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin, dem klose dia eyes make dem nor for fit si and hear with dia ear. Dia mind don block, so dem nor go fit undastand, but if to sey dem fit turn kom meet mi, I for heal dem.’
MAT 13:16 But God go bless una eye, bikos dem dey si well and una ear, bikos dem dey hear word.
MAT 13:17 I tell una true word, many profets and good-good pipol don wait taya make dem for hear and si wetin una dey si, but dem nor si or hear am.
MAT 13:18 “So, make una undastand wetin di farmer parabol mean:
MAT 13:19 ‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road.
MAT 13:20 Di seed wey fall for san wey get big-big stone, na pesin wey hear God word kon receive am with joy,
MAT 13:21 but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
MAT 13:22 Di seed wey fall for shuku-shuku, na pesin wey hear God word, but wahala, long-trot and to kwik get money for dis world kon shuk di word die for en heart and e nor kon bear fruit.
MAT 13:23 But di seed wey fall for betta groun, na pesin wey hear and undastand God word. E kom bear fruit wey rish hundred, sixty and thirty.’ ”
MAT 13:24 Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land.
MAT 13:25 But for nite wen evribody dey sleep, di enemy kon go plant grass join dem.
MAT 13:26 Wen di seeds grow kon dey bear fruit, di grass grow too.
MAT 13:27 “So di savants tell dia oga sey, ‘Nor bi good seed wi plant for yor farm? Na where di grass from kom?’
MAT 13:28 “Di oga ansa, ‘Na enemy plant dem.’ “So en savants sey, ‘Yu wont make wi go rut dem komot?’
MAT 13:29 “But di oga tell dem, ‘No, if una go rut di grass komot, una fit make mistake rut some for di good seeds too.
MAT 13:30 Make di good seeds and di grass grow togeda until harvest. Dat time, I go tell di pipol wey dey harvest sey, “Make una first rut all di grass, tie and burn dem, den gada di good seeds put inside my store.” ’ ”
MAT 13:31 Jesus kon tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like mustard seed wey one man plant for en farm.
MAT 13:32 Na di seed small pass but wen e grow, na di plant big pass oda plants for di farm and difren-difren birds kon build dia house for en branches.”
MAT 13:33 Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
MAT 13:34 Jesus tok all dis tins for parabol to di pipol. Evritin wey e tell dem, na parabol e use.
MAT 13:35 E do am so dat wetin di profet tok, go happen: “I go open my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”
MAT 13:36 Den Jesus kon leave di pipol enter inside house. En disciples kon tell am, “Tell us wetin di grass parabol for farm mean.”
MAT 13:37 Jesus ansa dem, “Pesin wey plant good seed na God Pikin;
MAT 13:38 di farm na di world and di good seed na di kingdom pipol. Di grass na devil shidren
MAT 13:39 and di enemy wey plant dem, na di devil. Di harvest na di last days and di harvest workers, na di angels for heaven.
MAT 13:40 “Just as dem gada di grass burn dem for fire, na so e go bi for di last day.
MAT 13:41 God Pikin go send en angels make dem go remove evritin inside en Kingdom wey dey make pipol sin and break God law.
MAT 13:42 Dem go trow dem inside fire wey nor dey kwensh, where dem go kry and grind dia tit.
MAT 13:43 Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!
MAT 13:44 “God Kingdom bi like gold wey dem beri for field. One pesin wey si am, kon hide am. With happiness, e go sell evritin wey e get buy di land.
MAT 13:45 “Again, God Kingdom bi like trada wey dey look for betta gold to buy.
MAT 13:46 Wen e si one gold wey dear well-well, e kon go sell evritin wey e get buy am.
MAT 13:47 Again, God Kingdom bi like net for sea wey katch difren-difren fish.
MAT 13:48 Wen di net full, dem drag am komot from di wota kon sidan bigin put di good fish inside difren kontaina and trowey all di bad one.
MAT 13:49 Na so e go bi for di day wen di world go end. Angels go kom separate evil pipol from di good ones
MAT 13:50 and dem go trow evil pipol inside hell-fire, where dem go kry and grind dia tit.”
MAT 13:51 Jesus ask dem, “Una undastand all dis tins?” Dem kon ansa, “Yes.”
MAT 13:52 Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”
MAT 13:53 Wen Jesus tok di parabol finish, e kon komot for der.
MAT 13:54 Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?”
MAT 13:55 “Nor bi di karpenter pikin bi dis? Nor bi Mary bi en mama? James, Josef, Simon and Judas, nor bi dia broda e bi?
MAT 13:56 Nor bi all en sistas dey stay here with us so? Na from where e for get all dis pawa?”
MAT 13:57 So dem kon dey vex for am. But Jesus tell dem, “Profet dey get respet for evriwhere, escept for en own village and among en family.”
MAT 13:58 So Jesus nor do many mirakle for der, bikos dem nor bilive am.
MAT 14:1 Dat time, Herod wey dey rule hear about Jesus,
MAT 14:2 so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
MAT 14:3 Before dis time, Herod don arrest John put for prison, bikos John dey akuiz am sey,
MAT 14:4 “E marry Herodias wey bi en broda Filip wife.”
MAT 14:5 Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.
MAT 14:6 So, for Herod birtday, Herodias dota dance well-well kon make Herod happy.
MAT 14:7 Sotey Herod promise sey e go gi-am anytin wey e ask for.
MAT 14:8 Just as en mama tell am, di girl kon sey, “Make yu give mi John di Baptist head for tray.”
MAT 14:9 Di tin pain di king well-well, but as e don promise and bikos of di pipol wey kom di party, e kon kommand make dem go kill John.
MAT 14:10 So e send en sojas go kut John head for inside prison.
MAT 14:11 Dem bring di head for tray kon give di girl and e karry am go give en mama.
MAT 14:12 Den, John disciples kon karry en body go beri and dem kon go tell Jesus wetin happen.
MAT 14:13 Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am.
MAT 14:14 As e kom down from di boat, e si plenty pipol, so e sorry for dem kon heal all di pipol wey nor well among dem.
MAT 14:15 Wen evening rish, en disciples kom meet am sey, “Dis place na wildaness and day don dey dark. Make yu send dis pipol go find food buy for demsef inside di village.”
MAT 14:16 Jesus ansa, “Dem nor nid to go, make una find sometin give dem chop.”
MAT 14:17 Dem kon tell am, “Na only five bread and two fish wi get for here.”
MAT 14:18 Jesus ansa dem again, “Make una bring di bread and fish kom.”
MAT 14:19 Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.
MAT 14:20 All of dem chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e rish twelf basket.
MAT 14:21 Di pipol wey chop na about 5,000 men, even doh dem nor kount wimen and shidren join.
MAT 14:22 Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side.
MAT 14:23 Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening.
MAT 14:24 By dis time, di boat don go far from land. Strong wave kom dey karry di boat up-and-down bikos heavy breeze dey blow.
MAT 14:25 For early morning, Jesus kon dey waka go meet en disciples on-top di wota.
MAT 14:26 Wen di disciples si am dey waka on-top wota, fear katch dem. Dem kon dey shake dey shaut, “Na ghost o-o!”
MAT 14:27 But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”
MAT 14:28 Naim Pita ansa, “Oga God, if na yu true-true, koll mi make I kom meet yu for di wota.”
MAT 14:29 So, Jesus tell am, “Make yu kom!” Pita komot from di boat kon dey waka on-top di wota go meet Jesus.
MAT 14:30 But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!”
MAT 14:31 At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
MAT 14:32 Wen di two of dem don enter di boat, di breeze kon stop.
MAT 14:33 Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
MAT 14:34 Wen dem don cross di river go di oda side, dem kon land for Gennesaret.
MAT 14:35 Wen di pipol for der know sey na Jesus, dem send message go all dia village, den dem kon bring all di pipol wey nor well kom meet am,
MAT 14:36 dey beg am sey, “Make di pipol wey nor well tosh yor dress” and all of dem wey tosh am, kon well.
MAT 15:1 Some Farisee pipol and law tishas kom meet Jesus for Jerusalem ask am,
MAT 15:2 “Why yor disciples nor dey obey awa eldas tradishon? Dem nor dey wosh dia hand before dem chop.”
MAT 15:3 Jesus ansa dem, “Why una nor dey obey God kommandment, na bikos una won keep una tradishon?
MAT 15:4 God sey, ‘Respet yor papa and mama, anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’
MAT 15:5 But una sey, ‘If anybody tell en papa or mama, “Wetin I won give yu before, I don gi-am to God”,
MAT 15:6 den e nor nid to respet en papa again.’ Bikos of una tradishon, una don make God word yeye.
MAT 15:7 Una wey dey pritend! True-true, na una Profet Isaya tok about wen e sey,
MAT 15:8 “ ‘Dis pipol dey praiz mi with dia mout, but dia heart dey far from mi
MAT 15:9 and di woship wey dem dey give mi, dey yuzles, bikos dem dey tish tradishon wey human being get.’ ”
MAT 15:10 Den Jesus gada di pipol kon dey tish dem, “Make una listin so dat una go undastand.
MAT 15:11 Nor bi wetin pesin chop dey make am dirty, but na wetin e tok from en mout.”
MAT 15:12 Den di disciples kon meet am sey, “Yu know sey Farisee pipol dey vex, bikos of wetin yu tok?”
MAT 15:13 Jesus ansa, “Any plant wey my Papa for heaven nor plant, dem go rut am trowey.
MAT 15:14 Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”
MAT 15:15 But Pita tell Jesus, “Tell us wetin yu mean.”
MAT 15:16 Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand?
MAT 15:17 Una nor know sey anytin wey pesin chop enter belle, e go shit am kom out?
MAT 15:18 But di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey make di pesin dirty.
MAT 15:19 Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.
MAT 15:20 Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”
MAT 15:21 Jesus komot der kon go Tyre and Sidon aria.
MAT 15:22 For der, one Kanaan woman kry kom meet am sey, “Oga God, David Pikin, make yu sorry for mi! My dota nor well, bikos demon dey trobol am!”
MAT 15:23 But Jesus nor tok. So en disciples kon beg am, “Drive dis woman komot for here, bikos e dey disturb us.”
MAT 15:24 Jesus kon tell di woman, “Na di sheep wey lost among Israel pipol, naim God send mi kom find.”
MAT 15:25 Di woman knee down for en front kon dey beg am sey, “Oga God, make yu help mi!”
MAT 15:26 Jesus tell am, “E nor good to give dog di bread wey shidren suppose to chop.”
MAT 15:27 Den di woman ansa, “Yes Oga God. But di dog demsef dey chop di small-small bread wey dey fall from dia oga tabol.”
MAT 15:28 So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
MAT 15:29 Jesus komot from der go Galilee wotaside. Den e klimb one mountin go sidan.
MAT 15:30 Many pipol karry pipol wey nor fit waka, blind, paralaiz, dumb and odas wey get difren sickness kom en front and e heal all of dem.
MAT 15:31 Di pipol kon sopraiz well-well wen dem si who nor fit tok, dey tok, who nor fit waka, dey waka, who blind before, dey si naw and all of dem kon praiz Israel pipol God.
MAT 15:32 Jesus koll en disciples kon tell dem, “I dey sorry for dis pipol bikos dem don dey here with mi for three days and dem nor get anytin to chop. I nor wont make dem go back with honga, so dat dem nor go faint for road.”
MAT 15:33 Di disciples ansa, “As dis pipol plenty so, where wi go fit get food wey go rish dem chop for dis wildaness?”
MAT 15:34 Jesus ask dem, “How many bread una get?” Dem ansa, “Na seven bread and some small-small fish.”
MAT 15:35 So, Jesus tell di pipol make dem sidan for groun,
MAT 15:36 kon take di seven bread and di fish. Afta e don tank God, e divide di bread and fish give en disciples make dem share am for di pipol.
MAT 15:37 Di pipol chop beleful and di food wey remain, full seven basket.
MAT 15:38 Di men wey chop na 4,000, even doh dem nor kount wimen and shidren join dem.
MAT 15:39 Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon enter boat go Magadan aria.
MAT 16:1 Di Farisee and Sadusi pipol kom test Jesus. Dem ask am make e show dem sign from heaven.
MAT 16:2 But Jesus tell dem, “Wen evening rish, una go sey, ‘Di weda go good bikos di sky red,’
MAT 16:3 and for morning, una go sey, ‘Rain go fall bikos di sky red and dark.’ Una sabi use di sky know how weda go bi, but una nor fit know di signs about di time wey God tok for en word.
MAT 16:4 Wiked and evil pipol for dis time dey ask for sign, but dem nor go get any one, escept Jonah sign.” Den Jesus kon waka leave dem.
MAT 16:5 Wen di disciples cross go di oda side, dem forget to take bread follow body.
MAT 16:6 Jesus kon tell dem, “Make una guide unasef against di Farisee and Sadusi pipol yist.”
MAT 16:7 So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”
MAT 16:8 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Una faith small o-o! Wetin make una dey kworel with unasef sey una nor take bread follow body?
MAT 16:9 So una neva still undastand? Una nor remember di five bread wey I take feed 5,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish?
MAT 16:10 Or di seven bread for di 4,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish too?
MAT 16:11 Why una nor undastand sey I nor dey tok to una about bread? But na make una for guide unasef against wetin di Farisee and Sadusi pipol dey tish!”
MAT 16:12 Den di disciples kon know sey nor bi bikos of bread make am dey warn dem, but na bikos of di tins wey di Farisee and Sadusi pipol dey tish.
MAT 16:13 Wen Jesus Christ rish Caesaria for Filippi aria, e kon ask en disciples, “Na who pipol sey Man Pikin bi?”
MAT 16:14 Dem ansa, “Some pipol sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and some dey sey na Jeremaya or one oda profet naim yu bi.”
MAT 16:15 Jesus kon ask dem, “Who una sey I bi?”
MAT 16:16 Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”
MAT 16:17 Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.
MAT 16:18 And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.
MAT 16:19 I go give yu heaven key, so dat anytin wey yor prayer tie for eart, dem go tie am for heaven and anytin wey yor prayer luz for dis eart, dem go luz am for heaven.”
MAT 16:20 Den Jesus kommand en disciples make dem nor tell anybody sey, na-im bi di Mezaya.
MAT 16:21 From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
MAT 16:22 So Pita take Jesus go one korna kon tell am, “Oga God! God forbid! Dis kind tin nor go ever happen to yu!”
MAT 16:23 But Jesus turn face Pita kon sey, “Satan, komot for my front! Yu bi stone wey block road, bikos yor mind nor dey for wetin God wont, but na wetin man wont.”
MAT 16:24 Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.
MAT 16:25 Anybody wey won save en life, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.
MAT 16:26 Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
MAT 16:27 God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.
MAT 16:28 I tell una true word, some of una dey here wey nor go die, before God Pikin go kom back with en kingdom.”
MAT 17:1 Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
MAT 17:2 Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.
MAT 17:3 At wons Moses and Elijah kon appear dey tok to Jesus.
MAT 17:4 So Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. If yu like, I go build three tent: one for yu, one for Moses and one for Elijah.”
MAT 17:5 As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”
MAT 17:6 Wen di disciples hear di vois, dem fear kon fall face groun.
MAT 17:7 But Jesus tosh dem kon sey, “Stand up! Make una nor fear.”
MAT 17:8 Wen dem look up, di only pesin wey dem si, na Jesus.
MAT 17:9 As dem dey kom down from di mountin, Jesus warn dem sey, “Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”
MAT 17:10 Di disciples ask am, “Why di law tishas dey tish sey na Elijah go first kom?”
MAT 17:11 Jesus ansa, “Na true sey Elijah go first kom and e go ripair evritin.
MAT 17:12 And I tell una sey, dat Elijah don kom, but pipol nor know am, instead dem do am as dem like. Na so too, God Pikin go sofa for dia hand.”
MAT 17:13 Den di disciples kon know sey e dey tell dem about John di Baptist.
MAT 17:14 Wen Jesus and en disciples meet di pipol, one man kon knee down for Jesus front
MAT 17:15 beg am sey, “Oga God, make yu sorry for my son, bikos e nor well and many times, di sickness dey sofa and trow am inside fire and wota.
MAT 17:16 I bring am kom meet yor disciples, but dem nor fit heal am.”
MAT 17:17 Jesus kon ansa, “Una wey nor get faith and wey nor know wetin to do! How long I go dey with una? How long I go bear with una? Make una bring di boy kom here.”
MAT 17:18 Den Jesus kommand di demon komot from di boy body and at wons, di boy kon well.
MAT 17:19 Wen only di disciples dey with Jesus, dem kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot from di boy body?”
MAT 17:20 Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’
MAT 17:21 Dis kind demon nor go gri komot from pesin body escept na with fasting and prayer.”
MAT 17:22 Wen dem enter Galilee, Jesus kon tell dem, “Somebody go sell Man Pikin give wiked pipol.
MAT 17:23 Dem go kill-am and for di third day, God go wake am up.” But di disciples nor happy, bikos of wetin Jesus tok.
MAT 17:24 Wen Jesus and en disciples rish Kapanaum, di pipol wey dey kollect tax for di temple kom meet Pita, ask am sey, “Yor oga dey pay Temple tax?”
MAT 17:25 Pita ansa, “Yes.” As Pita enter di house, Jesus kon ask am, “Wetin yu tink, Simon? Who dey pay tax give kings for dis world? Na pipol for di kountry or strenjas?”
MAT 17:26 Pita ansa, “Na strenjas dey pay tax.” So Jesus kon tell am, “Den dia own kountry pipol dey free,
MAT 17:27 but make dem nor for kause trobol, make yu go trow hook for river. Di first fish wey yu go katch, wen yu open en mout, yu go si money for inside, den make yu take di money pay di tax for mi and una.”
MAT 18:1 Dat time, di disciples kon ask Jesus, “Na who big pass for God Kingdom?”
MAT 18:2 Jesus kon koll one pikin stand for dia front,
MAT 18:3 den e ansa, “I tell una true word, unless una bi like small pikin, una nor go fit enter God Kingdom!
MAT 18:4 Anybody wey bring ensef down like dis small pikin, naim big pass for God Kingdom.
MAT 18:5 “Anybody wey welkom one pikin like dis one for my name, welkom mi.
MAT 18:6 But if pesin make one of dis small shidren wey bilive mi kommit sin, e betta make dem tie grindin stone for en neck, make e for sink inside river.
MAT 18:7 “Wahala dey for dis world, bikos of di sin wey pipol dey kommit! Na true sey trobol must kom, but e go bad for di pesin wey go kause di trobol.
MAT 18:8 If yor hand or leg dey make yu sin, make yu kut am trowey. E betta make yu enter God Kingdom without hand or leg, dan sey God trow yu inside fire wey nor dey kwensh.
MAT 18:9 If yor eye dey make yu sin, make yu pul am trowey. E betta make yu enter God Kingdom with one eye, down sey God trow yu enter hell-fire with two eyes.”
MAT 18:10 “Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.
MAT 18:11 Bikos Man Pikin kon save pipol wey lost.
MAT 18:12 “Wetin yu tink? If pesin get hundred sheep and one waka lost, e nor go leave di ninty-nine for di bush go find di one wey lost?
MAT 18:13 I tell una true word, wen e si am, e go happy for dat one pass di ninty-nine wey nor lost.
MAT 18:14 Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”
MAT 18:15 “If yor broda do yu bad, make yu go tell am wetin e do. If e asept wetin yu tell am, yu don win yor broda back bi dat.
MAT 18:16 But if e nor asept wetin yu tok, take one or two pipol follow body go meet am, bikos matter wey two or three pipol tok put, naim betta pass.
MAT 18:17 If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
MAT 18:18 “I tell una true word, anytin wey una take prayer tie for eart, God go tie am for heaven and anytin wey una take prayer luz for eart, God go luz am for heaven.
MAT 18:19 “Again, I tell una true word, if two of una for dis world gri and pray for anytin, my Papa for heaven go do am for una.
MAT 18:20 Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.”
MAT 18:21 Den Pita kon ask Jesus, “Oga God, how many times I go forgive my broda wey do mi bad? Na seven times?”
MAT 18:22 Jesus ansa am, “Nor bi only seven times I tell yu, but na four hundred and ninty times!”
MAT 18:23 “God Kingdom bi like wen one king wey won know how en savants dey manage en business.
MAT 18:24 As di king dey shek di akkount, dem kon bring one savant wey dey whole 10,000 koins kom.
MAT 18:25 Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.
MAT 18:26 “So, di savant fall for di king front dey beg, ‘Oga God, make yu dey patient with mi, I go pay yu evritin.’
MAT 18:27 Di king sorry for di savant kon release am sey make e nor pay again.
MAT 18:28 “Afta, di same savant kon si anoda savant wey dey hold am hundred silva koins. E seize am for troat nearly kill-am kon tell am, ‘Make yu pay mi my money.’
MAT 18:29 “Di savant wey e seize for troat kon fall for groun dey beg am, ‘Make yu dey patient with mi, I go pay yu yor money.’
MAT 18:30 “But e nor gri. Instead e karry am go put for prison, until e go pay wetin e whole.
MAT 18:31 Wen di oda savants si wetin happen, dem nor happy at-all, so dem kon go tell di king evritin wey happen.
MAT 18:32 “So di king koll di first savant kon tell am, ‘Yu wiked savant! I forgive yu di big debt wey yu whole mi, bikos yu beg!
MAT 18:33 Wetin make yu nor sorry for anoda savant like yu, just as I sorry for yu?’
MAT 18:34 With vexnashon, di king kon give di savant to soja make dem sofa am well-well, until e pay evritin wey e dey whole.
MAT 18:35 “So, na like dis too my Papa for heaven go do una, if una nor forgive una brodas from una heart.”
MAT 19:1 Wen Jesus tok finish, e kon komot from Galilee go Judea aria for di oda side for Jordan River.
MAT 19:2 Plenty pipol follow am and e heal all of dem.
MAT 19:3 Some Farisee pipol kom test and ask am sey, “E dey rite for man to drive en wife at-all?”
MAT 19:4 Jesus ansa, “Yu neva read am from di biginnin sey na man and woman God make
MAT 19:5 and bikos of dat, ‘Man go leave en papa and mama go join en wife and di two of dem go kon bi one?’
MAT 19:6 Dem nor bi two again, but one. So, wetin God don join togeda, make nobody skata am.”
MAT 19:7 Di Farisee pipol ask am again, “Wetin make Moses sey make wi drive awa wife?”
MAT 19:8 Jesus ansa, “Moses sey make una drive una wife, bikos una heart dey wiked, but nor bi so God plan am from biginnin.
MAT 19:9 Naw I tell una, anybody wey drive en wife, wey nor bi sey e sleep with anoda man, but kon marry anoda woman, don kommit adultery.”
MAT 19:10 Di disciples kon tell Jesus, “If na so husband and wife matter bi, e betta make pesin nor marry at-all?”
MAT 19:11 Jesus ansa dem, “Nor bi evribody go fit asept dis word, but na only di pipol wey God give di pawa.
MAT 19:12 Many men nor fit sleep with woman, bikos na so dem born dem, some na human being do dem like dat, but odas na bikos of God Kingdom. Anybody wey fit asept wetin I tok, make e take am like dat.”
MAT 19:13 Some pipol bring shidren kon meet Jesus make e put hand for dia head pray for dem. But di disciples kon bigin kworel with di pipol wey bring di shidren.
MAT 19:14 But Jesus tell di disciples, “Make una leave di small shidren make dem kom meet mi, nor stop dem, bikos na dem get God Kingdom.”
MAT 19:15 So e put en hand for dia head, bless dem, den e waka komot der.
MAT 19:16 One man kom meet Jesus, ask am, “Tisha, wish good tin I go do make I for fit enter God Kingdom?”
MAT 19:17 Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”
MAT 19:18 Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?” Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si,
MAT 19:19 respet yor papa and mama and make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
MAT 19:20 Di yong man ansa, “I dey obey all dis law with my heart. Wetin still remain wey I go do?”
MAT 19:21 Jesus tell am, “If yu won dey pafet, go sell evritin wey yu get, den give di money to poor pipol and yu go get betta tins for heaven. Wen yu don do wetin I tok, den make yu kom follow mi.”
MAT 19:22 Wen di yong man hear wetin Jesus tok, e vex waka komot, bikos e get money well-well.
MAT 19:23 Den Jesus tell en disciples, “I tell una true word, e go hard for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom!
MAT 19:24 Again, I dey tok sey, e go eazy for kamel to pass thru nidol whole, dan for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom.”
MAT 19:25 Di disciples sopraiz wen dem hear dis tins and dem kon ask, “Den who go fit dey save?”
MAT 19:26 Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
MAT 19:27 Den Pita kon tell Jesus, “Look, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu! Wetin dey for us naw?”
MAT 19:28 Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
MAT 19:29 And anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa or mama and land bikos of mi, go get am back hundred times and e go get life wey nor dey end.
MAT 19:30 So many pipol wey bi first naw, go bi last and doz wey bi last, go bi first.”
MAT 20:1 “God Kingdom bi like wen pesin komot for early morning go hire pipol wey go work for en farm.
MAT 20:2 Afta en and di workers don gri how mush dem go get for dia work, e kon send dem go work for en farm.
MAT 20:3 “Wen nine oklok rish for morning, e kon si pipol wey nor get work stand for market.
MAT 20:4 E kon tell dem, ‘Make una go work for my farm, I go pay una well.’
MAT 20:5 So dem kon go. Wen e go out around twelf and three oklok for aftanoon, e still tell oda pipol make dem go work for di farm.
MAT 20:6 Wen five oklok for evening don nearly rish, e si some pipol wey nor get work and e ask dem, ‘Why una nor dey work and today don nearly finish?’
MAT 20:7 “Dem ansa am, ‘Na bikos nobody hire us.’ “E kon tell dem, ‘Make una enter my farm go work.’
MAT 20:8 “Wen evening rish, di pesin wey get di farm kon tell en managa, ‘Koll di workers make yu pay dem, start from di last pipol wey I hire.
MAT 20:9 “Pipol wey dem hire for five oklok, kollect full day salari.
MAT 20:10 And wen di pipol wey dem first hire waka kom, dem tink sey di oga go pay dem pass like dat. But dem get di same amount.
MAT 20:11 Wen di first pipol kollect dia money, dem bigin komplain to di farm owner,
MAT 20:12 ‘Dis last pipol work for only one hour and wi work for di whole day inside hot sun, but yu pay all of us di same amount.’
MAT 20:13 “Di farm owner ansa one of dem, ‘My friend, I nor do yu bad. Nor bi wetin wi gri, dem pay yu?’
MAT 20:14 ‘Make yu take yor money dey go. I like give dis last pipol di same amount wey I give yu.
MAT 20:15 Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’
MAT 20:16 “So, di pesin wey bi last, go bi first and di first, go bi last.”
MAT 20:17 As Jesus dey go Jerusalem, e take en twelf disciples go one korna kon tok to dem.
MAT 20:18 “Make una look, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go sey make dem kill-am
MAT 20:19 and dem go gi-am to Gentile pipol make dem laf and flog am well-well, den dem go nail am for cross. But for di third day, God go wake am up.”
MAT 20:20 Den Zebedee wife with en shidren, James and John kom meet Jesus. Dia mama kon knee down dey beg Jesus.
MAT 20:21 Jesus kon ask am, “Wetin yu wont?” Di woman ansa, “Make yu allow dis my two boys sidan for yor kingdom, one for yor rite side and di oda for yor left.”
MAT 20:22 Jesus ask dem again, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from?” Dem ansa, “Yes! Wi go fit.”
MAT 20:23 Jesus kon tell dem, “Na true sey una go fit drink from my cup, but e nor dey my hand to choose who go sidan for my rite and left, but na for doz wey my Papa choose.”
MAT 20:24 So wen di oda ten disciples hear dis matter, dem kon dey vex with di two brodas.
MAT 20:25 But Jesus koll and tell dem, “Una know sey Gentile pipol oga and pipol for big pozishon dey kontrol and opress dia pipol.
MAT 20:26 Make e nor bi like dat among una! Instead, anybody wey won bi oga among una, must serve di rest pipol
MAT 20:27 and anybody wey wont bi first among una, must bi savant to di odas,
MAT 20:28 just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
MAT 20:29 As Jesus and en disciples dey komot from Jeriko, many pipol kon dey follow dem.
MAT 20:30 Two men wey blind sidan for di road korna. Wen dem hear sey Jesus dey pass, dem kon bigin shaut, “David Pikin, make yu sorry for us!”
MAT 20:31 Pipol kon dey shaut for dem make dem kwayet. But dem kon dey shaut more-more, “David Pikin, make yu sorry for us.”
MAT 20:32 Jesus kon stop, koll and ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
MAT 20:33 Dem ansa, “Oga God, make awa eye open again.”
MAT 20:34 Jesus sorry for dem, so e tosh dia eye. At wons, dem bigin si and dem kon follow Jesus.
MAT 21:1 As Jesus and en disciples near Jerusalem, dem kom rish Betpage for Mount Olives, so Jesus send two disciples
MAT 21:2 kon tell dem, “Make una go di village wey dey una front. Una go si one donkey and en pikin wey dem tie for der. Make una luz and bring dem kom meet mi.
MAT 21:3 If anybody ask, ‘Why una dey luz di donkey dem?’ Make una ansa, ‘Di oga nid dem and e go bring dem kom back naw-naw.’ ”
MAT 21:4 Dis tin happen so dat wetin di profet tok, go bi true:
MAT 21:5 “Tell Zion pipol, ‘Si! Una king dey kom meet una, e honbol ensef kon sidan on-top donkey.’ ”
MAT 21:6 Di disciples kon go do as Jesus tell dem.
MAT 21:7 Dem bring di donkey kon put dia klot make Jesus for sidan on-top.
MAT 21:8 Many pipol spread dia klot for road. Odas kut palm leaf kon spread dem for road too.
MAT 21:9 Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut, “Praiz David Pikin! Di pesin wey kom with God name, God go bless am! Make wi praiz God wey dey heaven!”
MAT 21:10 As Jesus enter Jerusalem, di town skata and pipol kon dey ask, “Who bi dis?”
MAT 21:11 Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”
MAT 21:12 Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.
MAT 21:13 Jesus kon tell dem, “God word sey, ‘Dem go koll my house, “Prayer House” ’, but una don turn am to where tif dey hide put!”
MAT 21:14 Jesus heal pipol wey blind and doz wey nor fit waka inside di temple yard.
MAT 21:15 But wen di priest oga dem and di law tishas si di wonderful tins wey Jesus dey do and hear shidren dey shaut, “Praiz, David Pikin” for inside di temple, dem kon dey vex.
MAT 21:16 So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”
MAT 21:17 Jesus kon leave dem go Betany kon stay der till day break.
MAT 21:18 For early morning, as Jesus dey go back to di town, e kon dey hongry.
MAT 21:19 E si one fig tree for road kon waka go where e dey, but e nor si anytin plok, bikos na only leaf di tree get. So e kon tell di tree, “Yu nor go ever bear fruit again!” At wons, di fig tree kon bigin die.
MAT 21:20 Wen di disciples si wetin happen, dem sopraiz kon sey, “Wetin make dis fig tree kwik die like dis?”
MAT 21:21 Jesus ansa dem, “I tell una true word, if una get faith and una nor dey doubt, una nor go only do wetin happen to dis fig tree, but if una tell dis mountin, ‘Make yu move go inside di sea, e go-go.’
MAT 21:22 If una bilive, una go get anytin wey una ask for, wen una pray.”
MAT 21:23 Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”
MAT 21:24 Jesus ansa dem, “I won ask una one kweshon. If una ansa mi, den misef go tell una wish pawa I take dey do dis tins.
MAT 21:25 Where John baptizim from kom? Na from heaven or pipol?” Dem kon dey tok about di matter among demsef sey, “If wi sey, ‘Na from heaven,’ E go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
MAT 21:26 But if wi sey, ‘Na from pipol,’ wi dey fear di pipol, bikos dem bilive sey na profet John bi.”
MAT 21:27 So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Jesus kon tell dem, “Misef nor go tell una wish pawa I take dey do all dis tins.”
MAT 21:28 “Wetin una tink? One man get two boys. E tell one, ‘My pikin, go work for my farm today.’
MAT 21:29 “Di boy ansa, ‘I nor go-go.’ But afta, e shange en mind kon go.
MAT 21:30 “Di papa kon tell di oda boy di same tin. Dis one kon ansa, ‘I go-go sir,’ but e nor go.
MAT 21:31 “Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?” Dem ansa, “Na di first one.” Jesus kon tell dem, “I tell una true word, tax kollectors and ashawo dem go first una enter God Kingdom!
MAT 21:32 John di Baptist kom show una di true road and una nor bilive am. But tax kollectors and ashawo dem bilive am. Even wen una si all dis tins wey I do, una still nor shange una mind kon bilive God.”
MAT 21:33 “Make una hear anoda parabol: One man plant vine for en farm, fence am round, dig pit where dem go for press di fruit wey dem go take make wine and build where sekurity go stay. Den e rent di farm give farmers kon travel go far place.
MAT 21:34 Wen harvest time rish, e send en savants go meet di farmers make dem gi-am en own share.
MAT 21:35 “But di farmers seize di savants, beat one, kill one and stone di oda one.
MAT 21:36 Den di man kon send some oda savants wey plenty pass di first ones go meet di farmers and dem do di same tin to dem.
MAT 21:37 At last, e send en own pikin go, dey tink sey, ‘May bi dem go respet my pikin.’
MAT 21:38 “But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’
MAT 21:39 So dem seize am, trow am komot from di farm kon kill-am.
MAT 21:40 “Wen di man wey get di farm go kom, ‘Wetin una tink sey e go do doz farmers?’ ”
MAT 21:41 Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”
MAT 21:42 Jesus kon tell dem, “Una neva read God word wey sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet don bikom di pila? Dis na God work and e dey wonderful for awa eye.’
MAT 21:43 “Na dis make mi tell una sey, ‘Dem go take God Kingdom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kind fruit wey E wont.’
MAT 21:44 Di pesin wey fall for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fall on-top, go grind to powder.
MAT 21:45 “Wen di priest oga dem and di Farisee pipol hear Jesus parabols, dem kon know sey e dey tok about dem.
MAT 21:46 So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”
MAT 22:1 Jesus kon tok to dem again for parabol sey:
MAT 22:2 “God Kingdom bi like wen one king do marriage for en son.
MAT 22:3 E send en savant go koll di pipol wey dem invite kom di party, but dem nor gri kom.
MAT 22:4 “Den e send oda savants sey, ‘Make una go tell di pipol wey wi invite sey, “Si! Di party go soon start. I don kill big melu and oda animals and evritin don ready, so make una kom for di marriage.” ’
MAT 22:5 “But di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, instead one go en farm and di oda kon go do en business.
MAT 22:6 Di oda one seize di savants, beat dem anyhow and kill some.
MAT 22:7 Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.
MAT 22:8 “Den e kon tell en savants. ‘Di marriage don start,’ di pipol wey I invite before, nor bi di pipol wey suppose kom.
MAT 22:9 So make una go di strits and invite evribody wey una si kom di party.
MAT 22:10 So di savants go di strits kon gada all di pipol wey dem si, both bad and good, kom di marriage and di hall kon full.
MAT 22:11 “Wen di king si di pipol wey kom di party, e kon si one man wey nor wear marriage klot.
MAT 22:12 So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am.
MAT 22:13 “Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
MAT 22:14 “Na only few pipol God choose from di many wey e koll.”
MAT 22:15 Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok.
MAT 22:16 So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo.
MAT 22:17 Wetin yu tink? E good make wi pay tax give Caesar?”
MAT 22:18 But Jesus know dia wiked plan, so e kon tell dem, “Una wey dey pritend! Why una one set trap for mi?
MAT 22:19 Make una show mi di money wey una dey take pay tax.” So dem bring di money kom.
MAT 22:20 Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dem stamp put for di money?”
MAT 22:21 Dem ansa, “Na Caesar own.” Jesus kon tell dem, “Den, make una give Caesar wetin bi Caesar own and give God, wetin bi God own.”
MAT 22:22 So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka leave am.
MAT 22:23 For di same day, di Sadusi pipol (wey bilive sey resureshon nor dey), kom meet and ask Jesus,
MAT 22:24 “Tisha, Moses tok sey, ‘If man wey nor get pikin die, en broda must marry en wife, so dat e go fit born pikin for en broda wey don die.’
MAT 22:25 Yu si, e get seven brodas wey dey stay here with us. Di first one marry, leta e kon die, since e nor get pikin, en broda kon marry en wife.
MAT 22:26 Di same tin happen to di sekond broda and di third one, go rish di nomba seven.
MAT 22:27 At last, di woman kon die too.
MAT 22:28 Wen pipol wey don die go kom back to life, wish pesin wife di woman go bi out of di seven brodas wey marry am?”
MAT 22:29 Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa.
MAT 22:30 For resureshon day, pipol nor dey marry or give woman out for marriage, bikos dem go bi like angel for heaven.
MAT 22:31 Koncerning weda pesin wey don die go kom back to life, una neva read wetin God tell una?
MAT 22:32 God sey, ‘I bi Abraham, Isaak and Jakob God. I nor bi God for pipol wey don die, but I bi God for pipol wey dey alive!’ ”
MAT 22:33 Wen di pipol hear as Jesus dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish.
MAT 22:34 Wen di Farisee pipol hear sey Jesus don make di Sadusi pipol kwayet, dem kon gada.
MAT 22:35 One of dem wey bi law tish kon ask Jesus one kweshon to take try am.
MAT 22:36 “Tisha, wish kommandment big pass?”
MAT 22:37 Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind.
MAT 22:38 Na dis bi di first kommandment and naim big pass.
MAT 22:39 Di sekond one bi like di first one: ‘Make pesin love en neighbour as e love ensef.’
MAT 22:40 Na dis two kommandments, Moses Law and wetin di profets tish, dey follow.”
MAT 22:41 As di Farisee pipol gada, Jesus kon ask dem one kweshon.
MAT 22:42 “Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?” Dem kon ansa, “Na David Pikin.”
MAT 22:43 Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey,
MAT 22:44 “Di OGA tell my Oga God sey, ‘Sidan for my rite hand, until I go put all yor enemies under yor leg.’
MAT 22:45 If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?”
MAT 22:46 So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.
MAT 23:1 Jesus kon tell di pipol and en disciples sey,
MAT 23:2 “Na di law tishas and Farisee pipol dey tok wetin Moses Law mean.
MAT 23:3 So make una listin and do wetin dem dey tell una. But nor do wetin dem dey do, bikos dem nor dey do wetin dem dey tish.
MAT 23:4 Dem dey put heavy load for pipol shoulder and dem nor ready to help dem.
MAT 23:5 “All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.
MAT 23:6 Dem like betta place for party and betta chair for inside sinagog.
MAT 23:7 Dem like make pipol dey greet dem with respet for market and make pipol dey koll dem, ‘Tisha.’
MAT 23:8 “Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas.
MAT 23:9 Make una nor koll anybody for dis world ‘Papa’, bikos na only one real Papa una get and e dey for heaven.
MAT 23:10 Make yu nor let pipol koll yu ‘Leader’, bikos na only one leader una get and na-im bi Christ.
MAT 23:11 Di pesin wey big pass among una, go bi una savant.
MAT 23:12 Anybody wey dey karry body up, God go bring am down and anybody wey nor dey karry body up, God go raiz am up.
MAT 23:13 “But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
MAT 23:14 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”
MAT 23:15 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!
MAT 23:16 “E go bad for una, leaders wey blind, una sey, ‘Anybody wey take di temple swear, nor-tin go do am. But if e take di gold for Temple swear, curse go dey for en head.’
MAT 23:17 Una bi fool wey blind! Wish one big pass, na di gold or di temple wey make di gold holy?
MAT 23:18 Una dey tish sey, ‘Anybody wey take di altar swear, nor-tin go do am, but if pesin take wetin dey for di altar swear, e must do wetin e tok.’
MAT 23:19 Una blind o-o! Wish one big pass, na di gift or di altar wey make di gift holy?
MAT 23:20 So, anybody wey take di altar swear, na both di altar and evritin wey dey inside, e take swear.
MAT 23:21 And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear.
MAT 23:22 Anybody wey take heaven swear, na both God throne and di Pesin wey sidan put, e take swear.
MAT 23:23 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one.
MAT 23:24 Una wey bi oga wey blind! Una dey remove fly from una drink, but una dey swallow melu!
MAT 23:25 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey wosh cup and plate body make dem for klean, but bad belle and long-trot full inside una.
MAT 23:26 Una Farisee pipol wey blind! Make una first wosh inside di cup, den di outside go klean too!
MAT 23:27 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una bi like grave wey fine for outside, but di pesin body for inside, don rotin.
MAT 23:28 Na so e bi with una too, for outside, una bi like good pipol, but for inside, na wayo and sin full una life.
MAT 23:29 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una build grave for di profet wey don die kon dekorate koffin for pipol wey fear God.
MAT 23:30 And una sey, ‘If to sey wi dey alive for awa grand-grand papa time, wi nor for help dem wen dem dey kill di profets.’
MAT 23:31 So na una grand-grand papa dem kill di profets.
MAT 23:32 Make una go finish di work wey una grand-grand papa dem start!
MAT 23:33 “Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?
MAT 23:34 I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.
MAT 23:35 So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.
MAT 23:36 I tell una true word, pipol for dis generashon go sofa di ponishment for dis tins wey una do!”
MAT 23:37 “O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.
MAT 23:38 Si, from today go, una go skata and una house go empty.
MAT 23:39 Make una know sey, una nor go si mi again until una go sey, ‘Make God bless di pesin wey kom with God name!’ ”
MAT 24:1 As Jesus dey komot from di temple, en disciples kon show am how di temple building bi.
MAT 24:2 Jesus kon tell dem, “Una dey si all dis tins? I tell una true word, wen di time rish, one block nor go dey on-top anoda one, bikos di building go skata finish!”
MAT 24:3 As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”
MAT 24:4 Jesus ansa dem, “Make una shine una eye, so dat nobody go fit deceive una.
MAT 24:5 Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol.
MAT 24:6 Una go dey hear rumor sey war dey happen for difren place. Make una nor fear, bikos e must happen, but di time wey I go kom, neva rish.
MAT 24:7 One kountry go fight with anoda kountry and one kingdom go fight with anoda kingdom. Honga go dey evriwhere and eartkweke go happen for difren place.
MAT 24:8 Wen dis tins go dey happen, e go bi like wen belle dey pain woman wey won born.”
MAT 24:9 “Dem go karry una wey bi my disciples give pipol wey go sofa and kill una. Bikos of mi, pipol for difren town wey nor know God, go hate una.
MAT 24:10 Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda.
MAT 24:11 Many wayo profets go kom and dem go deceive many pipol.
MAT 24:12 Bikos pipol nor go obey God law, di love wey many pipol get for God, nor go strong again.
MAT 24:13 But God go save di pesin wey go bear go rish end.
MAT 24:14 Before di world go end, my pipol go prish about God Kingdom go rish evriwhere.”
MAT 24:15 “As Profet Daniel tok, ‘Bad tins go happen for di Holy Place, inside di temple’ (Anybody wey hear dis word, make e undastand wetin e mean).
MAT 24:16 Pipol for Judea go run go on-top mountin.
MAT 24:17 Pesin wey dey on-top roof, make e nor kom down kon take anytin from en house
MAT 24:18 and pesin wey dey farm, make e nor go back to en house go take en klot.
MAT 24:19 For dis time, e go hard well-well for wimen wey get belle and doz wey get small pikin for hand.
MAT 24:20 Make una pray sey, e nor go bi for Sabat Day or Rainin Sizin naim all dis tins go happen,
MAT 24:21 bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.
MAT 24:22 And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.
MAT 24:23 So if anybody kon tell una sey, ‘Look o-o, Christ dey here or e dey der!’ Make una nor bilive am.
MAT 24:24 Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.
MAT 24:25 Make una remember wetin I dey tell una so, before dem go happen.
MAT 24:26 “So if anybody tell una sey, ‘Look, Christ dey inside bush,’ make una nor go, or ‘Look, e dey inside house,’ make una nor bilive.
MAT 24:27 Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.
MAT 24:28 Bikos na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”
MAT 24:29 “Afta di wahala wey go happen for dat time, “Di sun go kon dark and di moon nor go shine; stars go fall from heaven and heaven go dey shake.
MAT 24:30 “Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory.
MAT 24:31 God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”
MAT 24:32 “Make una hear di fig tree parabol: Anytime en branches dey bring leaf kom out, pipol go know sey dry sizin don near.
MAT 24:33 So wen una si all dis tins dey happen, make una know sey di time don rish and e dey near una door-mot.
MAT 24:34 I tell una true word, di pipol wey dey di world for dis time, nor go die finish before all dis tins go happen.
MAT 24:35 Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.
MAT 24:36 “Nobody know dat day or di time, even di angels for heaven nor know am, escept my Papa.
MAT 24:37 Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom.
MAT 24:38 For Noah time, before di flood kom, pipol dey chop and drink, dey marry and dey give dia pikin out for marriage, until di day wen Noah enter di ark.
MAT 24:39 Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.
MAT 24:40 Dat time, two men go dey for farm; one go vanish leave di oda one.
MAT 24:41 Two wimen go dey grind korn for engine, one go vanish leave di oda one.
MAT 24:42 “So, make una shine una eye, bikos una nor know di day wen Christ go kom.
MAT 24:43 But make una remember sey: If pesin wey get house know di time wen tif go kom for nite, e go ready ensef make di tif nor for enter en house.
MAT 24:44 So, make una dey ready, bikos Man Pikin go kom for di time wen una nor tink sey e go kom.
MAT 24:45 “Who bi di savant wey wise and good? Na di pesin wey en oga make leader among di oda savants, so dat e go give dem food for di korrect time.
MAT 24:46 E go good for dat savant wen en oga go kom back kon si am dey work.
MAT 24:47 I tell una true word, di oga go sey, ‘Make yu kare for di whole house.’
MAT 24:48 But if na wiked savant, e go tell ensef, ‘My oga nor go kwik kom back’,
MAT 24:49 so e go bigin beat di oda savants and e go dey chop and drink with drunkards.
MAT 24:50 Wen di oga go kom back for di day wen di savant nor espect and di time wen e nor know,
MAT 24:51 e go kut di savant to pieces kon trow am put for where pritendas dey, where e go dey kry and grind en tit.”
MAT 25:1 “God Kingdom bi like wen ten virgins karry dia lamps go meet man wey won marry wife.
MAT 25:2 Five get sense and five nor get sense.
MAT 25:3 Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body.
MAT 25:4 But di ones wey get sense karry estra kerosine.
MAT 25:5 E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.
MAT 25:6 “For mid-nite, somebody kon shaut, ‘Make una wake-up, di man wey won marry, dey kom o-o! Make una kom meet am.’
MAT 25:7 “So all di virgins wake-up, kon inkrease dia lite.
MAT 25:8 But di ones wey nor get sense kon tell di wise wons sey, ‘Make una give us some kerosine, bikos awa lite won kwensh.’
MAT 25:9 “But dem ansa, ‘No! Wetin wi get nor go rish wi share, instead make una go buy for unasef.’
MAT 25:10 “Wen dem go buy, di man wey won marry kon kom and di ones wey dey ready kon enter di party with am and dem kon lock di door.
MAT 25:11 “Afta, di oda virgins kom back dey sey, ‘Oga God, Oga God! Make yu allow us enter.’
MAT 25:12 “But e ansa dem, ‘No! I nor know una!’
MAT 25:13 “So, make una dey ready, bikos una nor know di day or time wen Christ go kom.”
MAT 25:14 “One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem.
MAT 25:15 E give one five koins, give anoda one two koins and di last, one koin. E give each savant wetin e go fit use, den e kon travel.
MAT 25:16 Di savant wey get five koins kwik-kwik go use en money trade kon gain five koins join wetin e get.
MAT 25:17 Di same way, di savant wey get two koins, gain two estra koins join en own.
MAT 25:18 But di savant wey get one koin kon go dig hole for outside, hide di money wey en oga gi-am.
MAT 25:19 “Afta, dia oga kon kom back make e for know how dem use di money wey e give dem.
MAT 25:20 Di savant wey e give five koins, kon bring anoda five koins join en own, sey, ‘Oga God yu give mi five koins. Si, I don gain five koins join dem.’
MAT 25:21 “En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’
MAT 25:22 “Di one wey dem give two koins still sey, ‘Oga God yu give mi two koins. Si, I don get two koins join dem.’
MAT 25:23 “En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’
MAT 25:24 “Den di savant wey e give one koin kon sey, ‘Oga God, I know sey yu bi wayo man, yu dey harvest wetin yu nor plant and dey pak fruits wey yu nor plok,
MAT 25:25 so fear katch mi and I kon hide yor money for groun. So oga, make yu take wetin yu give mi.’
MAT 25:26 “En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok,
MAT 25:27 yu for put my money for bank, so dat wen I kom back, I go kollect my money back with intrest!
MAT 25:28 “ ‘Make una take di money from am and gi-am to di savant wey get ten.
MAT 25:29 Bikos di pesin wey get sometin go get more and wetin e get, go plenty. But di pesin wey nor get, even di small one wey e get, dem go take am from am.
MAT 25:30 Make una trow dat wiked savant inside darkness for outside, where e go kry and grind en tit.’
MAT 25:31 “Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.
MAT 25:32 Evribody for di world go gada for en front and e go separate pipol as shepad dey separate sheep from goat.
MAT 25:33 E go keep di sheep for en rite hand and di goat for en left.
MAT 25:34 “Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.
MAT 25:35 Wen I dey hongry, una give mi food, wen I dey thirsty, una give mi sometin drink and wen I bi strenja, una let mi enter una house.
MAT 25:36 I dey naked and una give mi klot wear, wen I nor well, una kare for mi, wen I bin dey prison, una kom visit mi.’
MAT 25:37 “Den di raitious pipol go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu hongry and dey thirsty, kon feed and give yu sometin drink?
MAT 25:38 Wish time wi si yu as strenja, kon take yu enter awa house, or naked, kon give yu klot wear?
MAT 25:39 Wish time wi si yu wen yu nor well or dey for prison kon visit yu?’
MAT 25:40 “Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
MAT 25:41 “Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
MAT 25:42 Bikos di time wey I dey hongry and thirsty, una nor give mi food and wota drink.
MAT 25:43 Di time wen I bi strenja, una nor let mi enter una house, wen I dey naked, una nor give mi klot wear, wen I nor well and dey for prison, una nor kom visit mi.’
MAT 25:44 “Den, dem go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu dey hongry or won drink and wi nor give yu food or sometin to drink, wish time yu bi strenja or naked or nor well or dey for prison and wi nor give yu wetin yu wont?’
MAT 25:45 “Den, di king go ansa dem, ‘I tell una true word, just as una nor do am for di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una nor do am for mi.’
MAT 25:46 “So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
MAT 26:1 Wen Jesus tish finish, e kon tell en disciples,
MAT 26:2 “Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”
MAT 26:3 Di priest oga dem and di eldas kon whole meetin with Kaiafas, di High Priest, for en palis.
MAT 26:4 Dem kon plan for sekret to arrest Jesus make dem for kill-am.
MAT 26:5 But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”
MAT 26:6 Naw, as Jesus dey Betany for Simon, wey bi leper, house,
MAT 26:7 one woman bring kontaina wey get oil wey dear well-well kon pour di oil for Jesus head as e sidan for tabol dey chop.
MAT 26:8 Wen di disciples si wetin happen, dem kon vex well-well, ask di woman, “Why yu dey waste dis oil?
MAT 26:9 E for betta sey dem sell am kon give di money to poor pipol!”
MAT 26:10 Wen Jesus hear wetin dem tok, e kon sey, “Why una dey trobol dis woman? Na betta tin e do for mi o-o!
MAT 26:11 Poor pipol dey with una evritime, but mi, I nor go dey with una always!
MAT 26:12 Wen di woman pour dis oil for my body, e dey prepare mi for my beri.
MAT 26:13 I tell una true word, anywhere wey dem go for prish dis gospel, dem go take dis tin wey di woman do so, take remember am for di whole world.”
MAT 26:14 Den Judas Iskariot, wey dey among di twelf disciples go meet di priest oga dem,
MAT 26:15 kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am.
MAT 26:16 From dat time, Judas kon dey find how e go take sell Jesus Christ.
MAT 26:17 For di day wen dem start di Feast for di Bread wey nor get yist, di disciples kom meet Jesus Christ tell am, “Tell us where yu for won chop di Passova Food, so dat wi go-go prepare di place.”
MAT 26:18 Jesus tell dem, “Make una go inside di town and una go meet one man. Make una tell am, ‘Di tisha sey, “My time don rish. I go chop di Passova Food with my disciples for yor house.” ’ ”
MAT 26:19 So di disciples do as Jesus tell dem, den dem kon go prepare di Passova Food.
MAT 26:20 Wen evening rish, Jesus sidan for di tabol with en twelf disciples.
MAT 26:21 As dem dey chop, e kon sey, “I tell una true word, one of una go sell mi.”
MAT 26:22 Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?”
MAT 26:23 Jesus ansa dem, “Di pesin wey go put hand inside plate with mi, na-im go sell mi.
MAT 26:24 Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
MAT 26:25 Den Judas, di pesin wey go sell am, kon sey, “True-true, Oga God, na mi yu dey tok about?” Jesus ansa am, “Yu don tok am.”
MAT 26:26 As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”
MAT 26:27 Afta, e take di cup kon tank God, den e give dem kon sey, “Make all of una drink from am,
MAT 26:28 bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.
MAT 26:29 I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”
MAT 26:30 Afta dem sing one hymn, dem komot kon go Mount Olives.
MAT 26:31 Den Jesus kon tell dem, “Dis nite all of una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di shepad and di sheep go skata.’
MAT 26:32 But afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galilee, go wait for una.”
MAT 26:33 Pita kon ansa am, “If odas run leave yu, mi, I nor go ever leave yu!”
MAT 26:34 Jesus kon tell am, “I tell yu di trut, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.”
MAT 26:35 Pita still ansa, “Even if I go die, I nor go ever deny yu.” And all di disciples still tok di same tin.
MAT 26:36 Den Jesus go Getsemani with en disciples kon tell dem, “Make una sidan here bikos I wont cross go di oda side go pray.”
MAT 26:37 E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
MAT 26:38 Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
MAT 26:39 E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
MAT 26:40 Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
MAT 26:41 Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”
MAT 26:42 Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”
MAT 26:43 E kom back kon si en disciples dey sleep again; dem nor fit open dia eyes.
MAT 26:44 So e leave dem, go pray di same way for di third time.
MAT 26:45 Den e kon meet di disciples ask dem, “Una still dey sleep and rest? Si, di time don dey rish wen dem go sell Man Pikin give sinnas.
MAT 26:46 Make una stand up, make wi dey go. Si! Di pesin wey won sell mi, don dey kom!”
MAT 26:47 As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.
MAT 26:48 (Naw, di pesin wey sell am, don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest am!”)
MAT 26:49 At wons, Judas go meet Jesus, greet am kon sey, “Tisha”, den e kiss am.
MAT 26:50 Jesus tell am, “My friend, do wetin make yu kom.” Den dem whole Jesus kon arrest am.
MAT 26:51 But one of di disciples wey dey with Jesus draw en swod kom out, kon kut di High Priest slave ear komot.
MAT 26:52 Den Jesus tell am, “Put yor swod for where e dey before! Bikos anybody wey dey karry swod, na swod go kill-am.
MAT 26:53 Yu tink sey, I nor fit koll my Papa sey make e send many angels kom help mi naw-naw?
MAT 26:54 But if I do am, wetin dem rite for God word about dis matter, nor go happen.”
MAT 26:55 By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.”
MAT 26:56 Dis one happen so dat wetin di profets rite for di book go bi true. Den all di disciples kon run leave am.
MAT 26:57 Naw di pipol wey arrest Jesus take am go meet Kaiafas di High Priest, wey di law tishas and eldas don gada for en house.
MAT 26:58 But Pita follow dem go rish di High Priest yard. E kon sidan with di guards to si wetin go happen.
MAT 26:59 Di priest oga dem and di Sanhedrin kon dey find wetin dem go take whole Jesus, make dem for fit kill-am.
MAT 26:60 But dem nor si anytin to take hold am, even doh many pipol kom lie against am. At last, two pipol kom out
MAT 26:61 kon sey, “Dis man sey, ‘I go fit distroy God Temple and build am again for three days’.”
MAT 26:62 So, di High Priest kon stand up ask Jesus, “Yu nor get any ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?”
MAT 26:63 But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”
MAT 26:64 Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”
MAT 26:65 Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God!
MAT 26:66 Wetin una tink?” Dem kon ansa, “E do bad and e suppose to die.”
MAT 26:67 Dem kon spit for en face, beat am and some slap am,
MAT 26:68 dey sey, “Make yu tell us wetin go happen, yu wey bi Christ! Na who beat yu?”
MAT 26:69 As Pita sidan outside for di yard. One girl wey bi savant kon tell am, “Yorsef bin dey with Jesus Christ wey kom from Galilee.”
MAT 26:70 But Pita deny am for evribody front kon sey: “I nor know wetin yu dey tok about!”
MAT 26:71 Wen e komot go outside, anoda girl wey bi savant si am kon tell di pipol wey dey der, “Dis man sef dey with Jesus wey kom from Nazaret.”
MAT 26:72 Pita kon swear deny again, “I nor know di man!”
MAT 26:73 Afta sometaim, pipol wey stand for der, kom meet Pita tell am, “Yu really bi one of dem, even di way yu dey tok show sey yu dey with am!”
MAT 26:74 As e hear dis one, Pita kon dey swear, “I nor know di man!” Dat same time, fawol kon make, “Kukuruku.”
MAT 26:75 Den Pita kon remember wetin Jesus tell am, “Before fawol go make ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.” So Pita go outside bigin kry.
MAT 27:1 For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.
MAT 27:2 Dem tie am kon take am go meet Pilate, wey bi di govnor.
MAT 27:3 Wen Judas wey sell Jesus si sey dem kondemn am, en mind kon dey judge am for wetin e do, so e riton di thirty silva koins give di priest oga dem and eldas,
MAT 27:4 kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”
MAT 27:5 So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.
MAT 27:6 Di priest oga dem take di money kon sey, “Moses Law sey make dem nor put blood money for di temple pus.”
MAT 27:7 Afta dem don tok di matter, dem kon take di money buy one land wey di name bi “Potta Field” and na strenjas dem dey beri for der.
MAT 27:8 Na bikos of dis make dem dey koll di land “Blood Field” kon rish today.
MAT 27:9 So wetin profet Jeremaya tok kon happen: “Dem take thirty silva koins, di money wey Israel pipol don gri to take sell Jesus,
MAT 27:10 den dem use di money take buy, ‘Di Potta Field’, just as God tell mi.”
MAT 27:11 As Jesus stand for di govnor front, di govnor kon ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok!”
MAT 27:12 Wen di priest oga dem and di eldas dey akuiz Jesus, e nor ansa dem.
MAT 27:13 Den Pilate tell Jesus, “Yu nor hear all di tins wey dem dey tok sey yu do?”
MAT 27:14 But Jesus nor ansa and di govnor kon sopraiz well-well.
MAT 27:15 For Passova Feast, di govnor dey always release one prisona give di pipol.
MAT 27:16 Dat time, e get one wiked prisona and en name na (Jesus) Barabas.
MAT 27:17 So, wen dem don gada, Pilate ask dem, “Who una wont make I release give una? (Jesus) Barabas or Jesus Christ?”
MAT 27:18 (Bikos Pilate know sey na jealousy make dem bring Jesus Christ kom meet am.)
MAT 27:19 As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
MAT 27:20 But di priest oga dem and di eldas sey make di pipol ask for Barabas, so dat dem go fit kill Jesus Christ.
MAT 27:21 Di govnor kon ask dem again, “Wish one for dis two pipol una wont make I release give una?” Dem ansa, “Barabas!”
MAT 27:22 So, Pilate kon still ask dem, “Den wetin I go do with Jesus wey dem dey koll Christ?” All of dem kon ansa, “Nail am for cross!”
MAT 27:23 Pilate kon ask, “Why? Wish bad tin e do?” But dem kon dey shaut more-more, “Nail am for cross!”
MAT 27:24 Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”
MAT 27:25 Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”
MAT 27:26 Den Pilate release Barabas give dem. Afta dem flog Jesus Christ, Pilate kon gi-am to dem make dem nail am for cross.
MAT 27:27 Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am.
MAT 27:28 Dem remove en klot kon wear am klot wey make am bi like king.
MAT 27:29 Dem take shuku-shuku make crown wear am for en head, put walkin stik for en hand, den knee down for en front kon dey laf am dey sey: “Make una hail Jew pipol king o-o!”
MAT 27:30 Dem spit for en body kon take walkin stik nak en head many times.
MAT 27:31 Wen dem laf am finish, dem remove di king klot wey dem wear am kon wear am en own klot. Den dem take am go nail for cross.
MAT 27:32 As dem dey go outside, dem si one man from Sirene wey en name na Simon and dem kon force am make e karry Jesus Christ cross.
MAT 27:33 Wen dem rish one place wey dem dey koll Golgota (wey mean “Skull Place”),
MAT 27:34 dem kon give Jesus Christ betta wine make e drink. But wen e taste am, e nor gri drink am.
MAT 27:35 Wen dem don nail am for cross, dem kon gambol take divide en klot.
MAT 27:36 Dem sidan der dey look make anybody nor tosh am.
MAT 27:37 On-top of en head for di cross, dem rite wetin dem take akuiz am: “Dis na Jesus Christ, Jew pipol king.”
MAT 27:38 Dem still nail two tif near Jesus Christ for cross, one for en rite and di oda for en left hand.
MAT 27:39 So di pipol wey dey pass where Jesus Christ dey kon dey laf am and dey shake dia head
MAT 27:40 dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”
MAT 27:41 Na like dis too, di priest oga dem, di law tishas and di eldas dey laf am sey,
MAT 27:42 “E save oda pipol, but e nor fit save ensef! If e kom down naw from di cross, wi go bilive sey, na-im bi Israel King!
MAT 27:43 Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”
MAT 27:44 Di tifs wey dem nail for cross near Jesus Christ, still dey curse am too.
MAT 27:45 E kon happen sey, from twelf go rish three oklok for aftanoon, darkness kon kover di whole land.
MAT 27:46 Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”
MAT 27:47 Some of di pipol wey hear di word kon sey, “Dis Man dey koll Elijah make e kom help am.”
MAT 27:48 At wons, one of dem run go bring sponge kon soak am for wine wey don sawa, put am for stik, den kon give Jesus make e drink.
MAT 27:49 But di remainin pipol sey, “Leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
MAT 27:50 So Jesus Christ kry again, den e kon die.
MAT 27:51 At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.
MAT 27:52 Graves open and God pipol wey don die kom wake-up.
MAT 27:53 Afta Jesus raiz from grave, God pipol wey don die follow am raiz, den dem kon enter di holy Town with am and many pipol si dem.
MAT 27:54 Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
MAT 27:55 Many wimen wey follow Jesus Christ from Galilee and wey dey help am, dey der too. Dem dey look wetin dey happen for der.
MAT 27:56 Mary Magdalin, Mary, wey bi James and Josef mama and Zebedee shidren mama, dey der too.
MAT 27:57 Wen evening rish, Josef, one rish man from Arimatea, wey bi Jesus Christ disciple
MAT 27:58 go meet Pilate kon ask am for Jesus Christ body. So Pilate kon sey make dem gi-am di body.
MAT 27:59 So Josef karry di body kon wrap am with klean white klot.
MAT 27:60 E put am inside en own new grave wey e dig inside rock. Den e roll one big stone kover di grave mout.
MAT 27:61 (Mary Magdalin and di oda Mary sidan for di oda side wey face di grave).
MAT 27:62 Di next day (wey bi Sabat Day) di priest oga dem and di Farisee pipol kon gada for Pilate front
MAT 27:63 dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’
MAT 27:64 So make yu give orda make dem guide di grave until di three days go rish. If not, en disciples go-go tif en body kon tell pipol sey, ‘E don wake-up from deat’ and dis go make di last wayo worse pass di first one.”
MAT 27:65 So Pilate tell dem, “Make una take plenty sojas go guide di place as una wont.”
MAT 27:66 So dem karry sojas go guide di grave and dem kon block di grave mout, so dat Jesus Christ nor go fit kom out.
MAT 28:1 Wen day break for Sabat Day, wey bi di first day for di week, Mary Magdalin and di oda Mary kon go look di grave.
MAT 28:2 At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am.
MAT 28:3 En face bi like tonda lite and en klot white like snow.
MAT 28:4 Di guards kon dey shake and dem bi like pipol wey won die, bikos fear katch dem well-well.
MAT 28:5 But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross.
MAT 28:6 E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before.
MAT 28:7 Den make una kwik-kwik go tell en disciples sey, ‘God don raiz am from deat and e dey go wait for una for Galilee. Una go si am for der.’ Make una remember sey I tell una so!”
MAT 28:8 So dem run komot from di grave with fear and dem kon dey happy as dem dey go tell en disciples.
MAT 28:9 But Jesus Christ meet dem for road kon tell dem, “I greet una o-o!” Dem dress near am, hold en leg kon woship am.
MAT 28:10 Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
MAT 28:11 As dem dey go, some for di guards go inside di town go tell di priest oga dem evritin wey happen.
MAT 28:12 Afta dem don gada and plan with di eldas, dem kon give di sojas plenty money,
MAT 28:13 kon tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Jesus Christ disciples kom tif en body for nite wen wi dey sleep.’
MAT 28:14 If di govnor hear about dis matter, wi know wetin to tell am and una nor go enter trobol.”
MAT 28:15 So dem take di money kon do as di eldas tell dem. Pipol still dey tok dis story for evriwhere wey Jew pipol dey, kom rish today.
MAT 28:16 So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem.
MAT 28:17 Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt.
MAT 28:18 Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.
MAT 28:19 So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,
MAT 28:20 dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”
MAR 1:1 Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.
MAR 1:2 As Profet Isaya tok for di book wey e rite, “I dey send my messenja for front, go prepare di way for yu.”
MAR 1:3 One pesin dey shaut inside wildaness sey, “Make una prepare Oga God way for am, make una make en road strait.”
MAR 1:4 For inside wildaness, John di Baptist kon bigin prish sey, make pipol leave di bad tins wey dem dey do, make e for baptize dem, so dat God go forgive dem dia sins.
MAR 1:5 Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem, dey go meet John and e kon baptize dem for Jordan River afta dem konfess dia sins.
MAR 1:6 John wear klot wey dem take kamel hair make, tie leda belt for waist and e dey chop lokust and honey for inside bush.
MAR 1:7 E kon sey, “Pesin wey big pass mi dey kom for my back and I nor big rish who go luz di rope wey dey en shoe.
MAR 1:8 I dey use wota baptize una, but e go baptize una with di Holy Spirit.”
MAR 1:9 Dat time, Jesus kom from Nazaret wey dey for Galilee and John kon baptize am for Jordan River.
MAR 1:10 As Jesus dey kom out from di wota, heaven open and God Spirit kom down like dove kon land for en head.
MAR 1:11 Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi My Pikin wey I love and yu dey make belle sweet Mi well-well.”
MAR 1:12 At wons, God Spirit kon take am go inside di wildaness.
MAR 1:13 E stay inside di wildaness where Satan tempt am for forty days. E dey der with wiked animals and God angels kon gi-am evritin wey e wont.
MAR 1:14 Afta dem don put John for prison, Jesus kon enter Galilee dey prish di Good News sey,
MAR 1:15 “Di time wey God promise sey en kingdom go kom don rish. So make una leave di sins wey una dey do kon bilive di Good News.”
MAR 1:16 As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e kon si Simon and en broda Andru wey dey trow net inside river, (bikos dem bi Fisha men.)
MAR 1:17 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go give una pawa to katch pipol.”
MAR 1:18 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
MAR 1:19 As dem waka go front small, dem si James and John, wey bi Zebedee shidren inside boat dey ripair dia net.
MAR 1:20 At wons, Jesus koll dem, so dem leave dia papa, Zebedee, with di men wey dem hire for inside di boat, kon follow Jesus.
MAR 1:21 Jesus with en disciples kon go Kapanaum. Wen Sabat Day rish, Jesus kon enter di sinagog bigin tish.
MAR 1:22 Di pipol sopraiz, bikos e sabi tish pass di law tishas.
MAR 1:23 For inside di sinagog, one man wey evil spirit dey inside en body kon shaut dey sey,
MAR 1:24 “Make yu leave us o-o, Jesus wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroy us? I know who yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holy.”
MAR 1:25 But Jesus kommand am, “Shut up and kom out from di man!”
MAR 1:26 Afta di evil spirit don shake di man well-well, e shaut kon kom out from di man body.
MAR 1:27 Evribody sopraiz dey ask each oda, “Wish one bi dis? Dis new tishing strong o-o! Even wiked spirit dey obey en kommand.”
MAR 1:28 So, di story about wetin Jesus dey do kon spread kwik-kwik for evriwhere for Galilee.
MAR 1:29 As Jesus, James and John komot from di sinagog, dem kon enter Simon and Andru house.
MAR 1:30 Simon wife mama nor well, so dem kon tell Jesus about am.
MAR 1:31 Jesus go meet am, hold en hand and di woman kon stand up. Den di fever komot from en body and e kon dey serve dem.
MAR 1:32 Wen sun don dey go down for evening, dem kon bring all di pipol wey nor well and wey get demon kom meet Jesus.
MAR 1:33 Di whole town kon gada for di door-mot.
MAR 1:34 So, Jesus heal many pipol wey nor well with difren-difren diziz and e drive many demon komot from pipol body. But e nor let di demons tok, bikos dem know who e bi.
MAR 1:35 For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.
MAR 1:36 Simon and di pipol wey dey with am kon dey find am.
MAR 1:37 Wen dem si am, dem kon sey, “Evribody dey find yu.”
MAR 1:38 Jesus tell dem, “Make wi go anoda village, so dat I go prish for der too. Bikos na wetin I kom do, bi dat.”
MAR 1:39 So e kon go evriwhere for Galilee dey prish for dia sinagog and dey drive demon komot from pipol body.
MAR 1:40 One man wey bi leper kom meet Jesus, knee down for en front dey beg am sey, “If yu wont, yu go fit make mi well.”
MAR 1:41 Jesus sorry for di man, so e tosh am kon sey, “I wont, so make yu well!”
MAR 1:42 At wons, di leprosy komot from di man body and e kon dey okay.
MAR 1:43 So Jesus warn di man well-well as e dey go sey,
MAR 1:44 “Make yu nor tell anybody about wetin happen so, but go show yorsef to di priest. And make evribody for know sey yu don klean, make yu take di ofrin wey Moses kommand, follow body.”
MAR 1:45 But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.
MAR 2:1 Afta some days, wen Jesus go back to Kapanaum, news spread sey e dey house.
MAR 2:2 Many pipol kon gada and di house full sotey space nor dey to enter or stand near di door. So Jesus kon bigin prish God word give dem.
MAR 2:3 Some pipol kon karry one man wey paralaiz kom.
MAR 2:4 As dem nor si road pass go meet Jesus, bikos pipol plenty der, dem kon remove di zink on-top di house for where Jesus sidan, den dem kon small-small drop di bed wey di man liedan put till e rish groun.
MAR 2:5 Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey paralaiz, “My pikin, I forgive yu all yor sins.”
MAR 2:6 So some law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jesus tok for dia mind dey sey,
MAR 2:7 “Why dis man dey tok like dis? E dey shalenge God! Who fit forgive sins escept God?”
MAR 2:8 At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?
MAR 2:9 Wish one eazy pass to tok? ‘I forgive yu yor sins,’ or ‘Get up, karry yor bed make yu waka?’
MAR 2:10 But make dem for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sins, Jesus kon tell di man wey nor fit waka,
MAR 2:11 ‘I tell yu, get up, karry yor bed, make yu go yor house.’ ”
MAR 2:12 At wons, di man get up, karry en bed travel for dia front. Dem sopraiz well-well kon dey praiz God dey sey, “Wi neva si dis kind tin before!”
MAR 2:13 Jesus kon go di wotaside again and pipol kom meet am for der, so e kon start to tish dem.
MAR 2:14 As e dey waka for road, e si Levi, Afius pikin, sidan for where dem dey kollect tax. E tell am, “Make yu follow mi.” So Levi get up kon follow Jesus.
MAR 2:15 As Jesus dey chop for Levi house, many tax kollectors and sinnas dey chop with en and en disciples, bikos di pipol wey follow am, plenty.
MAR 2:16 Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”
MAR 2:17 Wen Jesus hear dis, e tell dem, “Pipol wey well nor nid doctor, but na doz wey nor well nid am. Nor bi good pipol I kom koll, but na sinnas I kom for.”
MAR 2:18 Naw, John di Baptist disciples and di Farisee pipol dey fast. So dem kom meet Jesus sey, “Why John disciples and di Farisee pipol dey fast, but yor disciples nor dey fast?”
MAR 2:19 Jesus ansa dem, “Pipol wey kom marriage nor fit fast wen di man wey dey marry dey with dem, abi dem suppose to? So-far di man wey dey marry dey with dem, dem nor nid to fast.
MAR 2:20 But di time dey kom wen dem go take di man wey dey marry from dem, by dat time, dem go fast.
MAR 2:21 “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, di pash go tear di klot more and di whole go big pass as e bi before.
MAR 2:22 Nobody dey pour new wine inside wine bag wey don old; if not, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go spoil. Instead, na inside new wine bag dem dey pour new wine put.”
MAR 2:23 Jesus kon dey waka pass di farm where dem plant korn put for Sabat Day and en disciples kon plok some korn as dem dey pass.
MAR 2:24 So di Farisee pipol tell am, “Si, why yor disciples dey break awa law for Sabat Day?”
MAR 2:25 Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men nor si food chop?
MAR 2:26 How en and en men enter God house wen Abiatar bi High Priest kon chop di holy bread wey only priests suppose chop?”
MAR 2:27 Jesus tell dem, “God make Sabat Day to help pipol, but nor bi sey make Sabat Day kontrol pipol life.
MAR 2:28 So, na God Pikin bi Sabat Day Oga God.”
MAR 3:1 Wen Jesus enter di sinagog again, one man wey en hand die, dey der.
MAR 3:2 Di Farisee pipol kon dey look Jesus with korna eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
MAR 3:3 So Jesus tell di man, “Make yu stand for centre make evribody si yu.”
MAR 3:4 Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.
MAR 3:5 So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
MAR 3:6 Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.
MAR 3:7 Den Jesus komot with en disciples go di wotaside and plenty pipol from Galilee follow am. Pipol from Judea,
MAR 3:8 Jerusalem, Idumea, some from across Jordan River and around Tyre and Sidon kom meet am wen dem hear about di tins wey e dey do.
MAR 3:9 Bikos of di pipol, Jesus kon tell en disciples make dem prepare one small boat for am, so dat pipol nor go push am anyhow.
MAR 3:10 Jesus heal many pipol, so all di pipol wey nor well kon dey push each oda, so dat dem go fit tosh am.
MAR 3:11 And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.”
MAR 3:12 But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
MAR 3:13 Jesus klimb go on-top mountin kon koll di pipol wey e wont, make dem kom meet am for der.
MAR 3:14 E choose twelf pipol (wey e koll apostles), so dat dem go dey with am and e go fit send dem go prish.
MAR 3:15 E kon give dem pawa to drive demons komot.
MAR 3:16 Na di twelf wey e choose bi dis: Simon wey e koll Pita,
MAR 3:17 James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).”
MAR 3:18 Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry),
MAR 3:19 and Judas Iskariot, wey sell Jesus give en enemies.
MAR 3:20 Jesus go house and plenty pipol kon gada am sotey en and en disciples nor fit chop.
MAR 3:21 Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”
MAR 3:22 Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, “Belzibub dey inside am” and “Na demon pawa e take dey drive demons komot from pipol body.”
MAR 3:23 So Jesus kon tok to di pipol for parabol sey: “How Satan go fit take drive Satan komot?
MAR 3:24 Any kingdom where pipol dey fight each oda, nor go fit stand.
MAR 3:25 And any family wey dey fight demsef, go skata.
MAR 3:26 So, if Satan kingdom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish.
MAR 3:27 Nobody go fit enter strong man house tif en propaty, unless e first tie di strong man, before e go fit tif en tins.
MAR 3:28 I tell una true word, God go forgive pipol di sins wey dem kommit and all di bad word wey dem tok.
MAR 3:29 But anybody wey tok bad word against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, bikos e don kommit sin wey go last forever.”
MAR 3:30 Jesus tok so, bikos some pipol sey, “Evil spirit dey inside am.”
MAR 3:31 Jesus mama and en brodas kom meet am. Dem stand for outside kon send pesin go koll am.
MAR 3:32 Di pipol wey sidan near Jesus kon tell am, “Yor mama and yor brodas dey outside, dem won si yu.”
MAR 3:33 But Jesus ansa dem, “Who bi my mama and my brodas?”
MAR 3:34 Den e look di pipol wey sidan round am kon tell dem, “Na my mama and my brodas bi dis pipol wey sidan here!
MAR 3:35 Bikos anybody wey do wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama.”
MAR 4:1 Again, Jesus kon bigin tish pipol for di wotaside. Since pipol wey gada round am many, e enter boat dey tish di pipol as dem sidan for groun near di wota.
MAR 4:2 E kon tish dem many tins for parabol sey:
MAR 4:3 “Make una Listin! One farmer go plant seed for en farm.
MAR 4:4 As e dey plant, some seed fall for road and birds kom chop dem.
MAR 4:5 Odas fall for where stones and san dey. Dem kwik grow kom out, bikos good soil nor dey der.
MAR 4:6 Wen sun kom out, e burn di plant, bikos dem nor get deep rut, dem kon die.
MAR 4:7 Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow kom out, di shuku-shuku, shuk dem die.
MAR 4:8 But odas fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”
MAR 4:9 Jesus kon sey, “Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok!”
MAR 4:10 Wen Jesus dey alone, pipol wey dey with am and en twelf disciples kon ask am about di parabol.
MAR 4:11 E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,
MAR 4:12 so dat, “dem go dey look, but dem nor go si, dem go dey hear, but dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom meet God make E forgive dem.”
MAR 4:13 Jesus kon ask dem, “Una nor undastand dis parabol? Den how una go take undastand any oda parabol?
MAR 4:14 Na God word di farmer dey plant.
MAR 4:15 Some pipol bi like di seed wey fall for road: anytime dem hear God word, Satan go kom tif am from dem kwik-kwik.
MAR 4:16 Some bi like di seeds wey fall for where stones and san dey: as dem hear God word, dem go receive am with happiness,
MAR 4:17 and bikos dem nor get rut and patient, wen trobol or wahala kom bikos of di word, dem go forget God word.
MAR 4:18 Odas bi like di seeds wey fall for where shuku-shuku full: dem hear di word,
MAR 4:19 but trobol for life, big eye for money and di way dem dey run follow oda tins, go kon block di word and e nor go bear anytin for dia life.
MAR 4:20 But di ones wey fall for betta groun, na doz wey hear di word kon receive am and bear many fruits, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”
MAR 4:21 Jesus still ask dem, “Pipol dey hide lamp for under basket? Nor bi on-top di place where dem dey keep lamp, dem suppose put am?
MAR 4:22 E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sekret naw, wey nor go kom out for open.
MAR 4:23 If anybody get ear, make e hear wetin I dey tok!”
MAR 4:24 Jesus kon tell dem, “Make una dey kareful for wetin una dey hear, bikos na wetin yu use take measure give oda pipol, na-im God go take measure for yu too and E go add join am.
MAR 4:25 Bikos anybody wey get, God go gi-am more, but anybody wey nor get, even di small one wey e get, God go take am from am.”
MAR 4:26 Jesus kon sey, “God Kingdom bi like pesin wey skata seed for groun.
MAR 4:27 Di pesin dey sleep and wake-up day and nite; di seed grow kom out, even doh di man nor know how e take happen.
MAR 4:28 As plant dey grow from groun, di body go first kom out, den di head go bear fruit and seed go kom out from inside.
MAR 4:29 Wen e ripe, di farmer go kut am, bikos di time to plok wetin e plant, don rish.”
MAR 4:30 Jesus kon ask dem, “Wetin wi go take kompare God Kingdom? Wish parabol wi go fit use take show as e bi?
MAR 4:31 E bi like mustard seed wey bi di seed wey small pass for di world, wey pesin plant for groun.
MAR 4:32 Afta dem don plant am, e go grow kon big pass all di oda plants and en branches go big and birds go land kon build dia nest for der.”
MAR 4:33 Na with many parabol like dis one, Jesus take prish God word to dem, so dat dem go fit undastand.
MAR 4:34 E nor get wetin e tell dem wey e nor use parabol. But wen only en and di disciples dey, e dey esplain evritin give dem.
MAR 4:35 Wen evening rish dat day, Jesus kon tell en disciples, “Make wi cross go di oda side for di river.”
MAR 4:36 So afta dem leave di pipol, dem enter di boat wey Jesus sidan and oda boat still dey der with dem.
MAR 4:37 Den, strong breeze kon dey blow and wota dey enter di boat, so di boat kon dey won sink.
MAR 4:38 But Jesus put en head for pillow dey sleep inside di boat. Den, dem koll am dey sey, “Tisha, yu nor even kare sey wi won die?”
MAR 4:39 So Jesus get up kon kommand di breeze, den e tell di river, “Make yu kwayet!” Di breeze stop and evriwhere kon kwayet at wons.
MAR 4:40 Den Jesus tell dem, “Why una dey fear? Una still nor get faith?”
MAR 4:41 Fear katch dem well-well and dem kon dey ask each oda, “Who dis man bi sef? Even breeze and river dey obey am!”
MAR 5:1 So Jesus and en disciples cross go di oda side for di river for Gerasenes aria.
MAR 5:2 As Jesus just dey kom down from di boat, one man wey get evil spirit kom out from di beri groun, run kom meet am.
MAR 5:3 Na inside beri groun di man dey stay and nobody dey fit tie am, even with shain.
MAR 5:4 Bikos dem don tie en hand and leg many times with shain and handcuff, but e dey kut dem trowey. Nobody strong rish to hold am.
MAR 5:5 Evriday and nite for di beri groun near where mountin dey, e dey shaut, dey use stone dey kut en body.
MAR 5:6 Wen e si Jesus dey kom from far, e run go meet am kon bow down for en front.
MAR 5:7 Den e shaut, “Make yu leave mi, Jesus, yu wey bi God Almighty Pikin! I take God beg yu, nor sofa mi!”
MAR 5:8 (Bikos Jesus don tell di demon before sey, “Komot from dat man body!”)
MAR 5:9 Jesus ask am, “Wetin bi yor name?” E ansa, “My name na ‘Legion,’ bikos wi plenty.”
MAR 5:10 E kon beg Jesus make e nor drive dem komot from di aria.
MAR 5:11 For di mountin side, plenty pig dey der dey chop.
MAR 5:12 So di demon beg Jesus sey, “Oga God, make yu allow us enter di pig dem body.”
MAR 5:13 So Jesus kon allow dem. So di evil spirit kom out from di man kon enter di pig dem. Den di pig dem run pass one low place enter di river and dem rish 2,000 wey die inside di wota.
MAR 5:14 So, di men wey dey guide di pigs for der, run go spread di news for di town and pipol for di aria kon go look wetin happen.
MAR 5:15 Wen dem waka kom meet Jesus, dem kon si di man wey demon dey inside am before sidan for der, e wear klot and en head korrect, so fear katch dem.
MAR 5:16 Pipol wey si wetin happen to di man wey get demon before kon tell odas wey kom.
MAR 5:17 Den dem beg Jesus make e komot for dia aria.
MAR 5:18 As Jesus dey enter boat, di man wey get demon kon ask weda e fit follow am.
MAR 5:19 But Jesus nor gri make di man follow dem. Instead e tell am, “Go yor house go meet yor pipol and make yu tell dem wetin God don do for yu, bikos God don sorry for yu.”
MAR 5:20 So di man kon go, bigin tok for di whole village about wetin God do for am and evribody wey hear am, sopraiz well-well.
MAR 5:21 Wen Jesus don cross go di oda side with boat, plenty pipol kon gada round am for di wotaside.
MAR 5:22 Den, one oga for di sinagog wey en name bi Jairus waka kom and wen e si Jesus, e fall for en front
MAR 5:23 dey beg am sey, “My small dota don nearly die. Make yu kom tosh am, so dat e go well again.”
MAR 5:24 Jesus and plenty pipol kon follow am and di pipol dey push Jesus from evry korna.
MAR 5:25 E get one woman among dem wey don dey mestrate for twelf years naw.
MAR 5:26 Dis woman don sofa well-well for many doctor hand and e don spend all di money wey e get, but instead of am towel, di sickness kon dey worse more-more.
MAR 5:27 Wen e hear about Jesus, e waka go where Jesus dey kon manage tosh en klot.
MAR 5:28 Bikos e tok for en mind sey, “If I go fit tosh en klot, I go well.”
MAR 5:29 At wons, di blood kon stop and e feel am for en body sey e don well.
MAR 5:30 Na wons, Jesus know sey pawa komot for en body. E kon turn round ask di pipol, “Who tosh my klot?”
MAR 5:31 En disciples kon ansa am, “Yu si all dis plenty pipol dey push yu and yu dey ask, ‘Who tosh mi?’ ”
MAR 5:32 But e kon dey look evriwhere make e for si di pesin wey tosh am.
MAR 5:33 Fear katch di woman wen e know wetin happen to am, so e kom meet Jesus, knee down for en front kon tell am evritin wey happen.
MAR 5:34 So Jesus tell am, “My pikin, yor faith don make yu well. Make peace follow yu and make yu well finish.”
MAR 5:35 As Jesus still dey tok, pipol from Jairus house waka kom tell Jairus sey, “Yor dota don die. Why yu still dey worry di tisha?”
MAR 5:36 Jesus nor listin to dem, but e kon tell di man, “Make yu nor fear, but make yu just bilive.”
MAR 5:37 Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.
MAR 5:38 Dem kon rish Jairus house kon si plenty pipol dey make nois, dey kry.
MAR 5:39 Wen Jesus enter, e tell dem, “Why una dey kry like dis? Di pikin neva die, e just dey sleep.”
MAR 5:40 Dem kon dey laf am. Jesus drive dem go outside, kon take di pikin papa and mama with di disciples wey follow am go inside di room where di pikin dead body dey.
MAR 5:41 Den e whole di pikin hand small-small kon tell am, “Talita kumi,” wey mean “Small girl, get up.”
MAR 5:42 Di girl (wey bi twelf years dat time) kon get up at wons bigin waka round di house. Evribody sopraiz for wetin happen.
MAR 5:43 But Jesus warm dem well-well sey, make dem nor let anybody know wetin happen so, den e kon tell dem make dem give di pikin food chop.
MAR 6:1 Jesus kon komot for dat place go en house town with en disciples.
MAR 6:2 Wen Sabat Day rish, e kon start to tish for di sinagog. Many pipol wey hear am sopraiz, dey sey, “Where e for get dis kind sense? Wish kind wisdom God gi-am? And wetin bi all dis mirakle wey e dey do so?
MAR 6:3 Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.
MAR 6:4 Den Jesus tell dem, “Na only for profet town, among en own pipol and for en own family na-im di profet nor dey get respet.”
MAR 6:5 Jesus nor fit do any mirakle for der, so e only tosh some pipol wey nor well kon heal dem.
MAR 6:6 Jesus sopraiz, bikos dem nor bilive am. So e komot from der go oda village wey near der kon tish dem.
MAR 6:7 Jesus koll di twelf disciples kon send dem two-by-two. E give dem pawa to drive evil spirits komot from pipol body.
MAR 6:8 E tell dem make dem only take dia walkin stik for di journey. E sey make dem nor karry bread, bag or money follow body.
MAR 6:9 E still sey, “Una fit wear shoe, but make una nor karry estra klot
MAR 6:10 and any house wey una enter, make una stay der until una komot for di place.
MAR 6:11 If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for any place, make una shake di san komot from una leg as una dey leave der, to show sey dem rijet di message.”
MAR 6:12 So, di disciples go out kon prish sey make evribody turn from sin kom meet God.
MAR 6:13 Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.
MAR 6:14 King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”
MAR 6:15 Odas sey, “Na Elijah e bi.” Some kon sey, “E bi like one profet wey dey before.”
MAR 6:16 But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”
MAR 6:17 Na Herod send men go arrest John put for prison, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e marry.
MAR 6:18 Bikos John don tell Herod plenty times sey, “E nor good as yu marry yor broda wife.”
MAR 6:19 So Herodias kon get bad belle for John and e won kill-am, but e nor fit.
MAR 6:20 Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.
MAR 6:21 But one day wen Herod dey do en birtday, en ofisas, en sojas oga dem and di leaders for Galilee, dey der with am.
MAR 6:22 Wen Herodias dota kom dance, Herod and di pipol wey e invite kon dey happy well-well. So di king kon tell di girl, “Make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”
MAR 6:23 Herod kon promise sey, “Anytin wey yu as mi, I go give yu, even if e go rish half of my kingdom.”
MAR 6:24 So di girl go outside go ask en mama, “Wetin I go ask for?” Di mama ansa, “Make yu ask for John di Baptist head.”
MAR 6:25 Kwik-kwik e rush go meet di king kon tell am wetin e wont, “I wont John di Baptist head for plate naw.”
MAR 6:26 Even doh e pain di king well-well, e nor won rijet wetin di girl ask, bikos e don promise for evribody present.
MAR 6:27 So di king send di soja wey dey kill criminals, make e go bring John head kom. So di man go inside di prison, go kut John head komot.
MAR 6:28 E put di head for plate kon give di girl and di girl go gi-am to en mama.
MAR 6:29 Wen John disciples hear wetin happen, dem kom karry en body go beri.
MAR 6:30 Den di disciples gada round Jesus kon tell am evritin wey dem don do and tish.
MAR 6:31 Jesus tell dem, “Make una follow mi make wi go rest for sometaim”, (Bikos many pipol dey-kom-dey-go and time nor dey to chop).
MAR 6:32 So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey.
MAR 6:33 But many pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place.
MAR 6:34 Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.
MAR 6:35 Wen day don dey dark, en disciples kom meet am sey, “Dis na place wey pipol nor dey stay and day don dey dark.
MAR 6:36 Make yu send dis pipol go buy wetin dem go chop for di town and village wey near here.”
MAR 6:37 But Jesus ansa, “Make una give dem sometin chop.” Dem kon sey, “Make wi go take two hundred silva koins buy bread give dem chop?”
MAR 6:38 Jesus ask dem, “How many bread una get? Make una go shek.” Wen dem don shek, dem kon ansa, “Na five bread with two fish.”
MAR 6:39 Jesus kon tell di pipol make dem share diasef into group, sidan for grass.
MAR 6:40 So dem sidan for difren-difren group, hundred-hundred, fifty-fifty.
MAR 6:41 Jesus take di five bread and two fish, e look heaven kon tank God, den e divide di bread. E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too.
MAR 6:42 All of dem chop beleful
MAR 6:43 and wen dem gada di fish and bread wey remain, twelf basket full.
MAR 6:44 Di pipol wey chop di bread, rish 5,000 men.
MAR 6:45 So Jesus tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side for Betsaida, den e send di pipol go house.
MAR 6:46 Afta e don tell dem bye-bye, e kon go pray for one mountin.
MAR 6:47 Wen evening rish, di boat don rish di sea centre, but Jesus still dey alone for land.
MAR 6:48 E si en disciples dey use all dia pawa dey padol di boat, bikos di breeze strong well-well. As morning won rish, Jesus waka kom meet dem, like sey e won pass dem.
MAR 6:49 Wen dem si am dey waka on-top di wota, dem tink sey na ghost, so dem kon dey shaut,
MAR 6:50 bikos as dem si am, fear katch dem. But Jesus tell dem, “Make una heart nor shake! Na mi. Make una nor fear.”
MAR 6:51 Den Jesus enter di boat with dem, den di breeze kon stop. Dem kon sopraiz well-well,
MAR 6:52 bikos dem konfuse and dem nor undastand how Jesus take feed 5,000 pipol.
MAR 6:53 Afta Jesus and en disciples don cross di river, dem kon rish Gennesaret, den dem tie dia boat for der.
MAR 6:54 As dem kom down from di boat, pipol kon si sey na Jesus bi dat.
MAR 6:55 Di pipol run pass all di aria, karry di pipol wey nor well for mat go where dem hear sey Jesus dey.
MAR 6:56 Anywhere wey Jesus go, weda na village or town or farm, dem go karry di pipol wey nor well for dia market place kon ask Jesus weda dem go fit tosh en klot and evribody wey tosh am, kon well.
MAR 7:1 Di Farisee pipol and some law tishas, wey kom from Jerusalem gada for where Jesus dey.
MAR 7:2 Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand.
MAR 7:3 (Bikos di Farisee and Jew pipol, nor dey chop unless dem wosh dia hand akordin to dia tradishon.
MAR 7:4 And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)
MAR 7:5 Di Farisee pipol and di law tishas kon ask Jesus, “Why yor disciples nor dey do akordin to awa tradishon, but instead dem dey chop with dirty hand?”
MAR 7:6 Jesus ansa dem, “Di tin wey Profet Isaya profesai about una, na true, bikos una dey pritend, as dem rite for God word, “ ‘Dis pipol dey praiz Mi with dia mout, but dia heart dey far from Mi.
MAR 7:7 Dem dey woship Mi for nor-tin, dey tish sey make pipol obey human being law.
MAR 7:8 Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”
MAR 7:9 Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own.
MAR 7:10 Bikos Moses sey, ‘Make yu respet yor papa and mama’ and ‘Anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’
MAR 7:11 But una sey e dey okay for pesin to tell en papa and mama sey, ‘Make yu nor vex, I nor fit help yu, bikos di money wey I suppose give yu, I don gi-am to God.’
MAR 7:12 So, like dis, una nor go let di pesin do good for en mama or papa.
MAR 7:13 Na so una dey use una tradishon wey una dey tish pipol take dey spoil God word. And una still dey do many tins like dis.”
MAR 7:14 Den Jesus koll di pipol again sey, “Evribody, listin to mi make una for undastand wetin I dey tok.
MAR 7:15 Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty.
MAR 7:16 Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”
MAR 7:17 Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol.
MAR 7:18 E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye?
MAR 7:19 Bikos nor bi di pesin heart e dey enter, na en belle and e go shit am komot. (Dis one mean sey all food dey klean.)”
MAR 7:20 Jesus kon sey, “Wetin kom out from pesin heart, naim dey make am dirty.
MAR 7:21 Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin,
MAR 7:22 to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom.
MAR 7:23 All dis evil tins dey kom from inside pesin and na dem dey make pesin dirty for God eye.”
MAR 7:24 Afta Jesus komot from der, e kon go di aria wey dem dey koll Tyre. Wen e enter one house, e nor wont make anybody know sey e dey der, but e nor fit hide.
MAR 7:25 One woman wey evil spirit dey worry en dota kon hear about Jesus and e kom meet am kon fall for en front.
MAR 7:26 Di woman na Greek wey kom from Sirofoenicia. E kon beg Jesus make e drive di demon komot from en pikin body.
MAR 7:27 But Jesus tell am, “Make di shidren chop beleful first, bikos e nor good to take shidren food give dog.”
MAR 7:28 Di woman ansa, “Yes, Oga God, but even dogs dey chop di small-small food wey dey fall from shidren plate.”
MAR 7:29 Jesus kon tell am, “Since yor faith strong rish to tok like dis, make yu dey go. Di demon don komot from yor pikin body.”
MAR 7:30 Wen di woman rish house, e kon si en pikin sleep for bed and di demon don leave am.
MAR 7:31 Den Jesus komot from Tyre kon pass Sidon go Galilee Sea for Dekapolis aria.
MAR 7:32 Some pipol karry one man wey nor dey hear or tok kom meet am sey make e tosh di man with en hand.
MAR 7:33 Wen Jesus don take di man go korna for where pipol nor dey, e kon put en two fingers inside di man ear, e spit for en hand kon tosh di man tongue.
MAR 7:34 Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”).
MAR 7:35 At wons, di man ear open, en tongue luz and e kon start to tok.
MAR 7:36 Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere.
MAR 7:37 Pipol sopraiz well-well dey sey, “Jesus don do evritin well. E even make di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don make dem dey tok.”
MAR 8:1 Dat time, plenty pipol gada and nor-tin dey for dem to chop. So Jesus koll en disciples tell dem,
MAR 8:2 “I dey sorry for dis pipol, bikos dem don dey here with mi for three days naw and dem nor get anytin to chop.
MAR 8:3 If I send dem go with honga, dem go faint for road and some kom from far place.”
MAR 8:4 Jesus disciples kon sey, “Where pesin go fit si bread buy wey go rish dis pipol chop, since pipol nor dey stay dis place wey bi wildaness?”
MAR 8:5 Jesus ask dem, “How many bread una get?” Dem ansa, “Na seven.”
MAR 8:6 Den Jesus sey make di pipol sidan for groun. Afta e take di seven bread tank God, e kon divide am give en disciples, sey make dem share am for di pipol.
MAR 8:7 Dem still get some small-small fish too and afta Jesus don tank God, e kon tell en disciples make dem share am for di pipol too.
MAR 8:8 Evribody chop beleful and di ones wey dem gada, full seven basket.
MAR 8:9 All di pipol wey chop rish 4,000 men. Den, Jesus kon send dem go house.
MAR 8:10 En and en disciples kon enter boat go Dalmanuta aria.
MAR 8:11 Di Farisee pipol kon dey argue with Jesus sey make e show dem sign from heaven, bikos dem won try am.
MAR 8:12 Jesus kon ask dem, “Why pipol for dis world naw dey ask for sign? Make I tell una true word, dem nor go get any sign.”
MAR 8:13 Den e kon leave dem enter boat go di oda side.
MAR 8:14 Jesus disciples forget to take bread join di ones wey dey with dem inside di boat.
MAR 8:15 Jesus kon tell dem, “Make una shine una eye, so dat una go guide unasef against di Farisee pipol and Herod yist!”
MAR 8:16 So, dem kon dey tok to each oda about di bread wey dem nor take follow body.
MAR 8:17 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Why una dey tok about bread wey una nor take? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish?
MAR 8:18 Una get eye, but una nor fit take am si? Una get ear, but una nor fit take am hear? Una nor dey remember anytin at-all?
MAR 8:19 Wen I divide five bread for 5,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?” Dem ansa, “Na twelf.”
MAR 8:20 “Den, wen I divide seven bread for 4,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?” Dem ansa, “Na seven.”
MAR 8:21 Den Jesus tell dem, “Una neva still undastand?”
MAR 8:22 Wen dem rish Betsaida, dem bring one man wey nor dey si kom meet Jesus make e tosh am.
MAR 8:23 E hold di man for hand kon take am go outside di village. Jesus spit for di man eye kon tosh am, den ask am, “Yu dey si anytin?”
MAR 8:24 Di man look up kon sey, “Yes, I dey si pipol, but dem bi like tree wey dey waka about.”
MAR 8:25 Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.
MAR 8:26 E kon tell di man make e dey go en house, but e warn am sey, “Make yu nor go inside di village again.”
MAR 8:27 Jesus and en disciples kon go di village dem wey dey Caesaria Filippi. As dem dey go for road, e kon ask en disciples, “Na who pipol dey sey I bi sef?”
MAR 8:28 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey, yu bi Elijah and some still sey, yu bi one for di profets.”
MAR 8:29 Jesus ask dem again, “But who una sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya.”
MAR 8:30 Den e warn dem make dem nor tell anybody who e bi.
MAR 8:31 Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”
MAR 8:32 As e nor hide dis tins from dem, Pita koll am go korna kon tell am, “Wetin yu dey tok so nor good o-o.”
MAR 8:33 But Jesus turn look en disciples kon shaut for Pita, “Satan! Make yu go my back, bikos yu nor put yor mind for wetin God wont. Na wetin human being wont, na der yor mind dey.”
MAR 8:34 Den Jesus koll di pipol with en disciples kon tell dem, “If anybody one follow mi, e must deny ensef, karry en cross, den kon follow mi.
MAR 8:35 Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi and dis gospel, go save am.
MAR 8:36 Wetin pesin go gain if e get di whole world and e luz en soul?
MAR 8:37 Wetin pesin fit use take eschnage for en life?
MAR 8:38 If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
MAR 9:1 Jesus kon tell dem, “I tell una true word, some pipol dey here wey nor go die until dem don si God Kingdom and en pawa.”
MAR 9:2 Afta six days, Jesus, Pita, James and John kon go one high mountin. E kon shange for dia front,
MAR 9:3 en klot kon dey shine well-well and e white pass how any dri-cleaner go fit wosh am.
MAR 9:4 Den Elijah and Moses kon appear for dia front dey tok with Jesus.
MAR 9:5 So, Pita tell Jesus, “Tisha, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.”
MAR 9:6 (Dem dey fear and dem nor know wetin to tok.)
MAR 9:7 Den, kloud kover dem and one vois kon tok from di kloud sey, “Dis na My only pikin wey I love. Make una listin to am!”
MAR 9:8 Wen dem look round, dem nor si anybody escept Jesus.
MAR 9:9 As dem dey kom down from di mountin, Jesus kon tell dem make dem nor tell anybody wetin dem si, until Man Pikin go don wake-up from deat.
MAR 9:10 Den dem kon dey tok with each oda about wetin dis “Wake-up from deat” mean.
MAR 9:11 Dem ask Jesus, “Wetin make di law tishas dey sey Elijah go first kom?”
MAR 9:12 Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’
MAR 9:13 But I dey tell una naw sey, Elijah don kom true-true and dem don do am wetin dem like, just as God tok for en word.”
MAR 9:14 Wen Jesus, Pita, James and John kom meet di oda disciples, dem si many pipol and di law tishas gada, dey argue with dem.
MAR 9:15 Wen di pipol si Jesus, dem sopraiz kon run kwik-kwik go greet am.
MAR 9:16 Jesus ask dem, “Wetin una dey argue about?”
MAR 9:17 One pesin among di pipol kon ansa, “Tisha, I bring my pikin wey get demon wey dey make am nor fit tok, kom meet yu.
MAR 9:18 Anytime di spirit seize am, e go trow am down and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en body go kon strait. I tell yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
MAR 9:19 Jesus kon ask en disciples, “Una wey nor bilive! How long I go stay with una? How long I go dey bear with una? Make una bring di boy kom meet mi.”
MAR 9:20 So, dem take di boy go meet am. Wen di spirit si Jesus, e kwik-kwik trow di boy for groun kon make am dey shake. Di boy fall for groun, dey roll and foam dey komot from en mout.
MAR 9:21 Jesus ask di boy papa, “Since wen dis tin don dey do am?” Di papa ansa, “Na since e bi small pikin.
MAR 9:22 Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die. But if yu go fit do anytin, make yu sorry for am and help us.”
MAR 9:23 Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
MAR 9:24 Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”
MAR 9:25 Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”
MAR 9:26 Di demon shaut, shake di boy well-well kon komot from en body. Di boy sleep for groun sotey many pipol kon dey sey, “E don die!”
MAR 9:27 But Jesus whole di boy hand small-small, karry am up and di boy kon stand up.
MAR 9:28 Wen e enter di house, en disciples kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot?”
MAR 9:29 Jesus ansa dem, “Na only with prayer and fasting dis kind one dey take komot.”
MAR 9:30 Jesus and en disciples kon komot from der pass Galilee. But Jesus nor wont make anybody know,
MAR 9:31 bikos e dey tish and tell en disciples sey, “Dem go sell Man Pikin give human being. Dem go kill-am and afta three days, e go wake-up again.”
MAR 9:32 But di disciples nor undastand wetin Jesus tok and fear nor let dem ask am wetin e mean.
MAR 9:33 Dem kon rish Kapanaum. So, wen Jesus don enter house, e kon ask en disciples, “Wetin una dey tok for road?”
MAR 9:34 But dem nor ansa, bikos wen dem dey kom for road, na who big pass among dem, dem dey argue about.
MAR 9:35 Afta Jesus sidan, e koll en twelf disciples kon tell dem, “If anybody among una won bi first, e go bi di last and e go bi evribody savant.”
MAR 9:36 E kon koll one small pikin stand for dia front. Den e whole di pikin hand, kon sey,
MAR 9:37 “Anybody wey welkom one of dis small pikin bikos of mi, na mi e welkom and anybody wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, but na my Papa wey send mi.”
MAR 9:38 John kon tell am, “Tisha, wi si one man wey use yor name dey drive demon komot from inside pipol body and wi kon try to stop am, bikos e nor dey follow us waka.”
MAR 9:39 But Jesus tell dem, “Make una nor stop am, bikos nobody wey use my name do mirakle go fit tok bad tin about mi.
MAR 9:40 Bikos anybody wey nor dey against us, dey for awa side.
MAR 9:41 I tell una true word, anybody wey give yu cup of wota bikos yu dey follow mi, nor go ever luz en reward.
MAR 9:42 “If anybody make one among dis small pikin wey bilive mi kommit sin, e go betta make dem tie big stone for en neck kon trow am inside river.
MAR 9:43 If yor hand go make yu sin, make yu kut am komot! E betta make yu enter inside God Kingdom with one hand, dan to get two hand kon enter hell-fire wey nor go ever kwensh,
MAR 9:44 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
MAR 9:45 If yor leg go make yu sin, make yu kut am komot. E betta make yu enter God Kingdom with one leg, dan to get two leg kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,
MAR 9:46 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
MAR 9:47 If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,
MAR 9:48 “di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
MAR 9:49 God go try evribody with fire.
MAR 9:50 “Salt good, but if e nor get taste again, how pesin go fit take make am sweet? Make una get salt inside una and make una dey live for peace with each oda.”
MAR 10:1 Jesus komot for dat place go Judea and Jordan River aria. Plenty pipol still gada kom meet am. E kon bigin tish dem as e dey do evritime.
MAR 10:2 Den, some Farisee pipol wey won test am kon ask am, “E bad make man drive en wife at-all?”
MAR 10:3 Jesus ask dem, “Wetin Moses kommand una?”
MAR 10:4 Dem ansa, “Moses sey make man rite leta to divorce en wife.”
MAR 10:5 But Jesus tell dem, “E tell una to do so, bikos una heart strong well-well.
MAR 10:6 But from di time God kreate di world, na man and woman naim E make.
MAR 10:7 Na dis make man dey leave en papa and mama go join en wife
MAR 10:8 and di two of dem go bi one. So dem nor go bi two again, but dem go bi one body.
MAR 10:9 So, wetin God don join togeda, make nobody separate am.”
MAR 10:10 Wen dem enter di house again, en disciples kon ask am about di matter.
MAR 10:11 Jesus ansa dem, “Anybody wey drive en wife, den e go marry anoda woman, don kommit adultery.
MAR 10:12 And any woman wey leave en husband, den e go marry anoda man, don kommit adultery too.”
MAR 10:13 Pipol kon dey bring shidren kom meet Jesus make e tosh dem, but en disciples dey shaut for di pipol wey bring dem kom.
MAR 10:14 But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom.
MAR 10:15 I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small shidren, nor go ever enter inside.”
MAR 10:16 Afta, Jesus draw di shidren near body kon bless dem.
MAR 10:17 As Jesus dey waka for road, one man run kom meet am sey, “Good Tisha, wetin I go do make I for get life wey nor dey end?”
MAR 10:18 Jesus ansa am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good espect God.
MAR 10:19 Yu know di kommandment; nor kill pesin, nor sleep with pesin wey yu nor marry, nor tif, nor lie for pesin head, nor shit pesin, respet yor papa and mama.”
MAR 10:20 Di man kon tell Jesus, “Tisha, I dey obey all dis law with all my heart since I bi small pikin.”
MAR 10:21 As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
MAR 10:22 Wen di man hear dis word, e vex komot der, bikos e get plenty money.
MAR 10:23 Den Jesus look round kon tell en disciples, “E go hard well-well for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom!”
MAR 10:24 Di disciple sopraiz for wetin Jesus tok. But Jesus tell dem again, “My shidren, e go hard well-well to enter God Kingdom o-o!
MAR 10:25 E go dey eazy for kamel to pass nidol whole, dan for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom.”
MAR 10:26 Dem sopraiz more-more kon dey ask each oda, “Den, who God go save?”
MAR 10:27 Jesus look dem kon ansa, “Dis tins hard well-well for human being, but nor bi for God, bikos evritin dey possibol for God.”
MAR 10:28 Pita kon tell am, “Si! Wot of wi wey don leave evritin wey wi get kon follow yu?”
MAR 10:29 Jesus ansa, “I tell una true word, e nor get anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa, mama, shidren or land bikos of di gospel,
MAR 10:30 wey nor go receive hundred times more dan di house, brodas, sistas, papa, mama, shidren and land wey e leave for dis world. Aldo e nor go eazy for dem, but di life wey nor go end for di world wey dey kom, go bi dia own.
MAR 10:31 But many pipol wey bi first naw, go bi last and pipol wey bi last naw, go bi first.”
MAR 10:32 Jesus and en disciples kon dey go Jerusalem. As Jesus dey waka for dia front, di disciples konfuse and doz wey dey follow dem kon dey fear, bikos dem nor know wetin go happen for der. Jesus koll en twelf disciples go korna again kon bigin tell dem wetin go happen to am.
MAR 10:33 “Si, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go kondemn am and dem go gi-am to di Gentile pipol.
MAR 10:34 Dem go laf am, spit for en body, flog am well-well kon kill-am, but afta three days, e go wake-up.”
MAR 10:35 Zebedee shidren, James and John, kom meet Jesus sey, “Tisha, wi wont make yu do wetin wi won beg yu.”
MAR 10:36 Jesus kon ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
MAR 10:37 Dem ansa, “Make yu allow us sidan with yu for yor kingdom, one for yor rite and di oda for yor left hand.”
MAR 10:38 Jesus ask dem, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I go drink from? Abi una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi?”
MAR 10:39 Dem ansa, “Wi go fit.” Den Jesus tell dem, “Una go really drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi,
MAR 10:40 but nor bi mi go tok who go sidan for my left or rite side, bikos e get di pipol wey God prepare am for.”
MAR 10:41 Wen di oda ten disciples hear wetin Zebedee shidren tell Jesus, dem kon dey vex for dem.
MAR 10:42 Jesus koll and tell dem, “Una know sey pipol wey dey rule di Gentile pipol dey do oga for dem and pipol wey dey high place dey use dia pozishon dey opress pipol.
MAR 10:43 But nor bi so e suppose bi among una. Anybody wey won bi oga among una, must bi una savant
MAR 10:44 and anybody wey won bi first among una, must bi evribody savant.
MAR 10:45 Bikos even Man Pikin nor kom make dem serve am, but e kom to serve pipol and to give en life make many pipol for dey save.”
MAR 10:46 Dem kon go Jeriko. As Jesus and en disciples with plenty pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, one beggar wey blind, sidan for road dey beg.
MAR 10:47 Wen e hear sey na Jesus wey kom from Nazaret dey pass, e kon bigin shaut, “Jesus Christ, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
MAR 10:48 Many pipol kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more sey, “David pikin, sorry for mi o-o!”
MAR 10:49 Jesus stop kon sey, “Make una koll am kom.” So, dem tell di blind man, “Make yu happy! Get up bikos Jesus dey koll yu.”
MAR 10:50 Bartimaeus trowey di klot wey e take kover body kon jump up go meet Jesus.
MAR 10:51 Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?” Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”
MAR 10:52 So, Jesus tell am, “Go, yor faith don heal yu.” At wons, di man kon dey si and e kon follow Jesus.
MAR 11:1 As Jesus and en disciples won enter Jerusalem, dem kon rish Betpage and Betany wey near Mount Olives, so Jesus send en two disciples go for dia front
MAR 11:2 kon tell dem, “Make una go di village wey dey for front. As una enter, una go si one small donkey wey dem tie for der, wey anybody neva ride before. Make una luz am kom.
MAR 11:3 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una sey, ‘Di oga nid am naw. Wi go bring am back leta.’ ”
MAR 11:4 So dem go kon si small donkey wey dem tie near one door for road and dem kon luz am.
MAR 11:5 Some pipol wey stand for der kon ask dem, “Why una dey luz dat small donkey?”
MAR 11:6 Dem kon tok as Jesus sey make dem tok, so di pipol kon let dem go.
MAR 11:7 Dem bring di small donkey kom meet Jesus kon spread dia klot on-top am, den Jesus kon sidan put.
MAR 11:8 Many pipol spread dia klot for road and some oda pipol spread palm leafs wey dem kut from bush.
MAR 11:9 Di pipol wey dey front and di ones wey dey follow am for back kon dey shaut,
MAR 11:10 God don bless awa papa David kingdom wey dey kom.
MAR 11:11 Jesus enter Jerusalem kon go inside di temple. Afta e don look evritin wey dey der, e kon go Betany with en twelf disciples, bikos day don dey dark.
MAR 11:12 Di next day, as dem dey komot for Betany, Jesus kon dey hongry.
MAR 11:13 E si one fig tree from far wey get plenty leafs, so e kon waka go look weda fruit dey for di tree. Wen e rish der, e si sey nor-tin dey di tree, na only leafs e get, bikos fig sizin neva rish.
MAR 11:14 E kon tell di tree, “Pipol nor go ever chop yor fruit again.” And en disciples hear wetin e tok.
MAR 11:15 Wen dem rish Jerusalem, Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell and buy for di temple varanda. E trowey di pipol wey dey shange money tabol and di pipol wey dey sell bird, e trowey dia chair too.
MAR 11:16 Jesus nor let anybody take anytin wey dem dey sell pass di temple varanda.
MAR 11:17 Den e tell dem, “Dem rite am sey, “ ‘Pipol go koll My house, Prayer house for di whole world.’ But una don turn am to where tif dey stay.”
MAR 11:18 Wen di priest oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan how dem go take kill Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.
MAR 11:19 Wen evening rish, Jesus and en disciples kon komot for di town.
MAR 11:20 For morning, wen Jesus and en disciples dey pass, dem kon si sey di fig tree don dey die from en rut.
MAR 11:21 Pita remember kon tell Jesus, “Tisha, look! Di fig tree wey yu curse yestiday don die.”
MAR 11:22 Jesus tell dem, “Make una get faith for God.
MAR 11:23 I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am.
MAR 11:24 Na dis make mi dey tell una sey, anytin wey una pray and ask God for, make una bilive sey una don get am and e go bi una own.
MAR 11:25 Anytime una dey pray, if una get anytin for mind against anybody, make una forgi-am, so dat una Papa wey dey heaven go forgive una too.
MAR 11:26 But if una nor gri forgive oda pipol, una Papa wey dey heaven nor go forgive una.”
MAR 11:27 Jesus and en disciples go Jerusalem again. Wen Jesus dey waka for di temple varanda, di priest oga dem, di law tishas and di eldas kom meet am sey,
MAR 11:28 “Na wish rite yu get to take dey do all dis tins? Who give yu di pawa?”
MAR 11:29 Jesus ansa dem, “I go ask una one kweshon. If una ansa mi, den I go tell una wish rite I get to dey do dis tins.
MAR 11:30 John baptizim, na from God, abi na from pipol e from kom? Make una ansa mi.”
MAR 11:31 Dem kon dey tok to each oda, “If wi sey, ‘Na from God,’ e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
MAR 11:32 But wi nor fit sey, ‘Na from pipol.’ ” bikos wi dey fear dis pipol, (since dem bilive sey John na profet).
MAR 11:33 So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Den, Jesus sey, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”
MAR 12:1 Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far.
MAR 12:2 Wen harvest time rish, e send one of en savant go meet di tenants make dem gi-am en own share for di harvest.
MAR 12:3 But di tenants seize di savant, beat am kon send am go back with empty hand.
MAR 12:4 Di man still send anoda savant go meet dem. Dem nak en head kon beat am anyhow.
MAR 12:5 E send anoda one again, dem kon kill-am. Na so dem beat and kill oda savants wey e send too.
MAR 12:6 “Di man get one pikin wey e love well-well and na dis one remain for am to send. At last, e kon send am go meet dem dey tok for en mind sey, ‘As dis one bi my pikin, dem go respet am.’
MAR 12:7 “But wen di tenants si am dey kom, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so. Make wi kill-am, so dat wi go get all di propaty for awasef.’
MAR 12:8 So dem seize am, kill-am kon trow en body outside di farm.
MAR 12:9 “Na wetin una tink sey di farm owner go do? E go distroy doz tenant kon give di farm to oda pipol.
MAR 12:10 Una neva read God word wey sey, “ ‘Di stone wey di builders rijet, don turn to di main stone?
MAR 12:11 Dis na wetin God do and e good for awa eye well-well.’ ”
MAR 12:12 Naw, dem won kon arrest am, but dem dey fear di pipol, bikos dem know sey Jesus tok dis parabol against dem. So dem kon waka leave am.
MAR 12:13 Dem send some Farisee and Herod pipol, make dem find way to katch Jesus with wetin e go tok.
MAR 12:14 Wen dem meet am, dem kon ask am, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut, yu nor dey do wayo and yu dey tish di trut about God way. E good make wi dey pay tax give Caesar, abi make wi nor pay?”
MAR 12:15 But Jesus know dia wayo, so e tell dem, “Why una dey test mi? Make una bring one koin make I si.”
MAR 12:16 So dem bring one koin and Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dey di money so?” Dem ansa, “Na Caesar own.”
MAR 12:17 Jesus tell dem, “Make una give Caesar di tins wey bi Caesar own and make una give God di tins wey bi God own.” Dem sopraiz well-well for wetin Jesus tok.
MAR 12:18 Di Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus tell am,
MAR 12:19 “Tisha, Moses rite give us sey: ‘If man broda die and en wife nor born for am, en broda must marry di woman, make dem for born shidren for di broda wey don die.’
MAR 12:20 E get seven brodas. Di first one marry and wen e die, e nor get shidren.
MAR 12:21 Di sekond one kon marry di woman and e nor still get pikin before e die and na so e happen for di third one.
MAR 12:22 No one for di seven brodas wey marry di woman get pikin. At last, di woman too kon die.
MAR 12:23 For di time wey pipol go wake-up from deat, na wish pesin wife di woman go kon bi, as e bi sey all di seven brodas marry am?”
MAR 12:24 Jesus ansa dem, “Una nor know sey una dey deceive unasef, bikos una nor know God word and en pawa.
MAR 12:25 Wen pipol wake-up from deat, dem nor go marry again, instead dem go bi like angels for heaven.
MAR 12:26 Naw, for di matter about pipol wey go wake-up, una neva read for di book wey Moses rite about di bush wey fire dey burn and how God tell Moses, ‘Na Mi bi Abraham, Isaak and Jakob God?’
MAR 12:27 God nor bi God for di pipol wey don die, but na for di pipol wey dey alive. Na big mistake una dey make so!”
MAR 12:28 So, one man wey sabi di law kon dey hear dem dey argue. Wen e si sey Jesus dey ansa dem well, e kon ask am, “Wish kommandment big pass?”
MAR 12:29 Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi.
MAR 12:30 Make una love God una Oga God with all una heart, soul and all una pawa.’
MAR 12:31 Di sekond one na, ‘Make una love una neighbour as una love unasef.’ E nor get any kommandment wey big pass dis two.”
MAR 12:32 Di man wey dey tish di law kon tell Jesus, “Na thru, Tisha. Yu dey korrect for wetin yu tok, na only God bi Oga God and know oda god dey apart from am.
MAR 12:33 To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
MAR 12:34 Wen Jesus si sey di man tink well before e ansa, e kon tell di man, “Yu nor dey far from God Kingdom.” From dat time, nobody get di mind to ask am any kweshon again.
MAR 12:35 As Jesus dey tish for di temple varanda, e kon sey, “Why e bi sey di law tishas dey sey Christ na David pikin?
MAR 12:36 Di Holy Spirit pawa make David tok sey, “ ‘God tell my Oga God, sidan for my rite hand until I go put yor enemies under yor leg.’
MAR 12:37 If David ensef koll Christ, ‘Oga God,’ how Christ go kon take bi en pikin again?” Di pipol wey gada kon dey listin to am with happiness.
MAR 12:38 Wen Jesus dey tish, e kon sey, “Make una dey kareful about di pipol wey sabi di law. Dem like to waka about with long klot and dem like loud greetin for market,
MAR 12:39 di chair wey betta pass for sinagog and high tabol for party, na der dem dey like sidan put.
MAR 12:40 Woman wey en husband don die, dem dey kollect en propaty and dem dey pray long prayer make pipol for si dem. Na dia ponishment go worse pass.”
MAR 12:41 Den, Jesus sidan face di ofrin box, dey look as pipol dey put money inside. Many rish pipol kon dey put plenty money inside.
MAR 12:42 One poor woman wey e husband don die kon kom, put two koins wey nor rish one penny for inside di box.
MAR 12:43 Jesus kon koll en disciples sey, “I tell una true word, dis poor woman wey e husband don die put money wey pass di oda pipol own.
MAR 12:44 Bikos di oda pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but dis woman, as e poor rish, put evritin wey e get for life.”
MAR 13:1 As Jesus dey komot from di temple varanda, one of en disciple kon sey. “Tisha, si di fine-fine stone wey dem take build dis house!”
MAR 13:2 Jesus ansa, “Una dey si all dis big house? Dem nor go even leave one stone on-top anoda. All of dem go skata!”
MAR 13:3 As Jesus sidan for Mount Olives wey face di temple, Pita, James, John and Andru kom meet am wen odas nor dey and dem kon sey,
MAR 13:4 “Make yu tell us wish time dis tins go happen and wetin go bi di sign to show sey di time for dis tins to happen, don rish?”
MAR 13:5 Jesus ansa dem, “Make una take kare, so dat nobody go deceive una.
MAR 13:6 Many pipol go kom with my name sey, ‘Na mi bi Christ’ and dem go deceive many pipol.
MAR 13:7 Wen una hear about war wey dey happen and rumor sey war won happen, make una nor fear. All dis tins must happen, but time neva rish wen di world go end.
MAR 13:8 Difren kountries and kingdoms go fight each oda. Eartkweke and honga go dey for many place. But wen di wahala won start, e go bi like wen woman won born.
MAR 13:9 “Make una shine una eye. Dem go take una go kourt and dem go beat una for sinagog. Bikos of mi, una go stand for govnors and kings front, so dat una go fit tell dem about mi.
MAR 13:10 Before di world go end, pipol must first prish di gospel for evry kountry for dis world.
MAR 13:11 Wen dem arrest una karry go kourt, make una nor worry about wetin una go tok. God go give una wetin to tok for dat time, bikos nor bi una go tok, but na di Holy Spirit go tok thru una.
MAR 13:12 “Broda go betray en broda make dem kill-am and papa go sell en pikin. Shidren go betray dia papa and mama and dem go kill dem.
MAR 13:13 Evribody go hate una bikos of my name. But di pesin wey go fit bear rish end, go dey save.”
MAR 13:14 “Wen una si wetin nor suppose happen dey happen for di Holy Place (make di pesin wey dey read, know wetin dis word mean), den doz wey dey Judea, must run go mountin.
MAR 13:15 Make di pesin wey dey on-top house nor kom down or go inside en house go kollect anytin.
MAR 13:16 Make di pesin wey dey farm nor go back to en house go kollect klot.
MAR 13:17 For dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle and doz with pikin wey still dey suck breast!
MAR 13:18 Make una pray sey dis tins nor go happen for di time wen kold dey well-well.
MAR 13:19 Bikos wen dis tins go dey happen, di kind sofa wey go dey, neva dey since wen God kreate dis world and dat kind sofa, nor go dey again.
MAR 13:20 If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.
MAR 13:21 Dat time, if anybody tell una, ‘Look! Make una si Jesus for here!’ or ‘Si am for der!’ make una nor bilive dem.
MAR 13:22 Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.
MAR 13:23 Make una take kare! I don tell una evritin before di time go rish.”
MAR 13:24 “But for dat time, afta di sofa, “di sun go dark and di moon nor go shine again.
MAR 13:25 Di stars go fall from heaven and di pawa wey dey whole di sky, go shake.
MAR 13:26 “Den evribody go si Man Pikin dey kom from inside kloud with strong pawa and glory.
MAR 13:27 Den, God go send en angels go gada di pipol wey E don choose from di for korna for di world go rish heaven.”
MAR 13:28 “Make una learn wetin dis fig tree parabol mean: Wen en branches don dey soft and en leaf dey fall komot, make una know sey dry sizin don near.
MAR 13:29 So wen unasef si dis tins dey happen, make una know sey di time wey Man Pikin go kom, don near.
MAR 13:30 I tell una true word, di pipol for dis time nor go die finish before all dis tins go happen.
MAR 13:31 Heaven and eart go vanish, but my word go dey forever.”
MAR 13:32 “Di day or di time wen dis tins go happen, nobody know am, even angels for heaven nor know and God Pikin sef nor know too. Na only di Papa, for heaven know am.
MAR 13:33 Make una dey wosh and shine una eye, bikos una nor know wen di time go rish.
MAR 13:34 E go bi like wen man dey travel go far. E leave en house make en savant look am, give dem work do kon tell di gateman make e wosh en house.
MAR 13:35 “So make una shine una eye, bikos una nor know wen di house owner go kom back, weda na for evening, nite, morning or wen day don break.
MAR 13:36 If not, e go fit kom back wen una nor espect and e go meet una dey sleep.
MAR 13:37 Wetin I dey tell una so, I dey tell evribody. So make una shine una eye!”
MAR 14:1 Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.
MAR 14:2 Dem sey, “Make wi nor do am naw wen dem dey do di Feast, so dat pipol nor go rayot.”
MAR 14:3 Wen Jesus dey Betany for Simon house (wey get leprosy before), e sidan with dem to chop, naim one woman bring oil inside alabasta box kom, di oil dear well-well and dey send fine. Afta e don open di kontaina, e pour di oil for Jesus head.
MAR 14:4 But some pipol wey dey der kon dey vex, dey tell each oda, “Why dis woman dey waste oil wey dear well-well like dis?
MAR 14:5 Dem for sell am pass three hundred silva koins and give di money to poor pipol!” So, dem kon vex dey tok to di woman anyhow.
MAR 14:6 But Jesus ansa dem, “Make una leave di woman alone. Why una dey wori-am? Na good tin e do for mi so o-o!
MAR 14:7 Poor pipol go always dey with una and una go fit do good for dem anytime una like. But mi, I nor go dey with una always!
MAR 14:8 Dis woman don do wetin e fit do. E anoint my body to prepare mi for beri before di time go rish.
MAR 14:9 I tell una true word, anywhere wey dem go prish dis gospel for di whole world, pipol go tok about dis tin wey dis woman don do so.”
MAR 14:10 Den Judas Iskariot, wey dey among Jesus disciples, kon go meet di priest oga dem sey e won sell Jesus give dem.
MAR 14:11 Wen dem hear am, dem happy well-well kon promise am money. So, Judas kon bigin find how e go fit take sell Jesus give dem.
MAR 14:12 Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”
MAR 14:13 Jesus send two disciples go for front kon tell dem, “Wen una enter di town, una go si one man wey karry wota kontaina. Make una follow am.
MAR 14:14 Di house wey e go enter, make una tell di pesin wey get am sey, ‘Di Tisha sey make wi ask, “Where di room wey mi and my disciples go for chop Passova food?” ’
MAR 14:15 E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey. Make una prepare evritin for der.”
MAR 14:16 So en disciples go di town and dem si evritin just as Jesus tell dem sey e go bi, dem kon prepare di Passova food for der.
MAR 14:17 Wen evening rish, Jesus kon go di house with en twelf disciples.
MAR 14:18 As dem dey chop for di tabol, Jesus kon sey, “I tell una true word, one of una wey dey chop with mi, go sell mi give my enemies.”
MAR 14:19 Wetin Jesus tok kon dey worry di disciples for mind, so dem kon dey ask am one-by-one, “Oga God! Na mi?”
MAR 14:20 Jesus ansa, “Na one of una wey dey follow mi chop for di same plate.
MAR 14:21 Man Pikin go die as dem rite for God word about am, but curse dey di pesin head wey go sell am. E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”
MAR 14:22 As dem dey chop, Jesus take bread, tank God, den divide am give en disciples kon sey, “Make una take and chop, bikos dis na my body.”
MAR 14:23 Afta, e take cup, tank God, den e give en disciples and all of dem, drink from inside.
MAR 14:24 E kon tell dem, “Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribody.
MAR 14:25 I tell una true word, I nor go drink wine again, until di day wen I go drink di new wine for God Kingdom.”
MAR 14:26 Afta dem don sing one hymn, dem kon enter inside Mount Olives.
MAR 14:27 Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di pesin wey dey look di sheep and di sheep go skata.’
MAR 14:28 But afta God don wake mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galilee.”
MAR 14:29 Pita kon sey, “Even if odas run leave yu, I nor go run leave yu o-o!”
MAR 14:30 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’ two times, yu go don deny mi three times.”
MAR 14:31 But Pita still sey, “Even if I go die with yu, I nor go ever deny yu.” All of dem still tok di same tin.
MAR 14:32 Jesus and en disciples kon go one place wey dem dey koll Getsemani and Jesus tell dem, “Make una sidan for here, bikos I won go pray.”
MAR 14:33 E take Pita, James and John follow body. E mind kon dey trobol am and e nor dey happy.
MAR 14:34 E kon tell dem, “My heart dey heavy well-well like sey I won die. So, make una stay here dey wosh.”
MAR 14:35 E waka go front small kon fall face groun, bigin pray, “Papa! If yu wont, make yu let dis sofa pass mi.”
MAR 14:36 Jesus kon pray, “My Papa, e nor get wetin yu nor fit do. Make yu take dis sofa cup from mi. But nor bi as I wont am, but na as yu wont.”
MAR 14:37 Wen Jesus kom back, e meet en disciples dey sleep, so e tell Pita, “Simon, yu dey sleep? Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
MAR 14:38 Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”
MAR 14:39 E komot again, go pray as e pray before.
MAR 14:40 Wen e kom back again, e si sey dem still dey sleep; dem nor dey pray, so dem nor know wetin to tell am.
MAR 14:41 E kom di third time kon ask dem, “Una still dey sleep? Di sleep don do, bikos time don rish! Make una si, dem don sell Man Pikin give sinnas.
MAR 14:42 Make una get up make wi dey go. Si, di pesin wey won sell mi, dey kom!”
MAR 14:43 As Jesus still dey tok, Judas, one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.
MAR 14:44 (By dis time, di man wey won sell Jesus don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest and hold am well-well.”)
MAR 14:45 Wen Judas kom, e go meet Jesus kon sey, “Tisha!” Den e kiss am.
MAR 14:46 So, di pipol kon seize and arrest Jesus.
MAR 14:47 One pesin wey stand for der kon take en swod kut di High Priest savant ear komot.
MAR 14:48 Jesus kon tell dem, “Na mi una karry swod and big-big stik kom arrest like sey I bi tif?
MAR 14:49 I dey with una evriday for di temple dey tish, but una nor arrest mi den.” Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word, go bi true.
MAR 14:50 Den all en disciples kon run leave am.
MAR 14:51 One yong man wey tie small klot for waist, dey follow Jesus. So dem won kon arrest di man join,
MAR 14:52 but e kon run komot with nakednes and leave en klot for der.
MAR 14:53 Den, dem take Jesus go meet di High Priest, so all di priest oga dem, di eldas and di law tishas kon gada.
MAR 14:54 Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda. E sidan with di guards dey warm en body near fire.
MAR 14:55 Di priest oga dem and di Sanhedrin dey find wetin dem go take akuiz Jesus, so dat dem go fit kill-am, but dem nor si anytin.
MAR 14:56 Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins, but dia story nor gri with each oda.
MAR 14:57 Some pipol stand up kon lie against am sey,
MAR 14:58 “Wi hear wen e sey, ‘I go distroy dis Temple wey dem build with hand and afta three days, I go build anoda one wey dem nor use hand build.’ ”
MAR 14:59 All dia story nor dey good, bikos dem nor gri with each oda.
MAR 14:60 Den di High Priest stand for dia front kon ask Jesus, “Yu nor get ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?”
MAR 14:61 But Jesus kwayet and e nor ansa dem. Den di High Priest kon ask am again, “Na yu bi Christ wey bi God Pikin?”
MAR 14:62 Jesus ansa, “Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand, wen e dey kom inside di kloud from heaven.”
MAR 14:63 Den di High Priest tear en own klot kon sey, “Why wi dey find more pipol to tok for dis matter?
MAR 14:64 Una don hear di word wey e tok against God! Wetin una tink sey make wi do am?” Dem kon ansa, “E suppose to die.”
MAR 14:65 Den some bigin spit for Jesus body, dem tie en eye kon dey nak am dey sey, “Profesai naw!” Di pipol wey dey guide di place still join beat am.
MAR 14:66 For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der.
MAR 14:67 Wen e si Pita sidan dey warm ensef, e look am well-well kon sey, “Yorsef dey follow dat man wey kom from Nazaret, wey dem dey koll Jesus Christ.”
MAR 14:68 But Pita deny kon sey, “I nor even know wetin yu dey tok about!” Den e waka go di gate and fawol kon do, “Kukuruku!”
MAR 14:69 Wen di savant girl si am, e kon dey tell di pipol wey stand der sey, “Dis man dey among dem.”
MAR 14:70 But e deny again. Small time, di pipol wey stand for korna kon tell Pita, “True-true, yu dey among dem, bikos na Galilee yu from kom.”
MAR 14:71 Pita kon bigin curse and swear sey. “I nor know dis man wey una dey tok about so o-o!”
MAR 14:72 At wons, fawol kon do, “Kukuruku!” di sekond time. So Pita kon remember wetin Jesus tell am: “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ two times, yu go deny mi three times.” Den Pita kon bigin kry well-well.
MAR 15:1 For early morning afta dem don plan wetin dem go do Jesus, di priest oga dem with di law tishas and di Sanhedrin, tie am kon take am go meet Pilate.
MAR 15:2 So Pilate ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok.”
MAR 15:3 Den di priest oga dem still dey akuiz am,
MAR 15:4 so Pilate ask Jesus again, “Yu nor get anytin to tok? Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu do?”
MAR 15:5 But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.
MAR 15:6 Anytime wen dem dey do di Passova Feast, Pilate always dey free one prisona wey di pipol ask for.
MAR 15:7 Barabas, one man wey kill pesin for di time wey dem dey rayot, dey prison with pipol wey nor dey obey govment law.
MAR 15:8 Den di pipol kom meet Pilate kon ask am sey, make e free one prisona for dem, as e dey do before.
MAR 15:9 So Pilate ask dem, “Una wont make I free Jew pipol king for una?”
MAR 15:10 (Pilate know sey di priest oga dem bring Jesus to am, bikos dem dey jealous).
MAR 15:11 But di priest oga dem tell di pipol make dem ask Pilate make e free Barabas.
MAR 15:12 So Pilate ask dem again, “Den wetin una wont make I do to dis man wey una koll Jew pipol king?”
MAR 15:13 Dem kon shaut, “Kill-am trowey!”
MAR 15:14 Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do?” But dem kon dey shaut more-more, “Kill-am trowey!”
MAR 15:15 Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
MAR 15:16 So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada.
MAR 15:17 Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head.
MAR 15:18 Dem kon dey salot am, “Wi hail yu o-o, Jew pipol king!”
MAR 15:19 Dem take stik nak am for head kon spit for en body. Dem knee down for en front dey bow for am.
MAR 15:20 Wen dem don laf am finish, dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot. Den, dem kon go kill-am.
MAR 15:21 Di sojas kon force Simon, one man from Sirene, wey just dey enter di town, make e karry Jesus cross. (Di man na Alexanda and Rufus papa.)
MAR 15:22 Dem take Jesus go di place wey dem dey koll Golgota (wey mean, “Skull Place”).
MAR 15:23 Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh, but Jesus nor gri drink am.
MAR 15:24 Dem nail am for cross kon divide en klot, dey trow dice make dem for know wetin go rish each pesin.
MAR 15:25 Na nine oklok for morning dem take nail Jesus for cross.
MAR 15:26 Dem kon rite sey, “Dis na Jew pipol king.”
MAR 15:27 Dem nail two tif with am for cross, one for en left and di oda for en rite side.
MAR 15:28 Wetin dem rite for God word kon happen sey, “Dem kount Jesus join bad pipol.”
MAR 15:29 Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.
MAR 15:30 Oya! Save yorsef make yu kom down from di cross!”
MAR 15:31 Even di priest oga dem and di law tishas dey laf Jesus for where dem sidan, dey sey, “E save oda pipol, but e nor fit save ensef!
MAR 15:32 Christ, wey sey e bi Israel king, make e kom down from di cross naw make wi si am, so dat wi go bilive!” Doz wey dem nail for cross with am kon dey curse am too.
MAR 15:33 Wen twelf oklok for aftanoon rish, darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon.
MAR 15:34 Around three oklok, Jesus kon shaut sey, “Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?” Wey mean, “My God! My God! Wetin make yu abandon mi?”
MAR 15:35 Wen some pipol wey stand near der hear wetin e tok, dem kon sey, “Listin. E dey koll Elijah!”
MAR 15:36 Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine, den e put am for stik give Jesus make e drink, den e kon sey, “Make una leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
MAR 15:37 But Jesus shaut again, den e kon die.
MAR 15:38 So di curtain for di temple tear into two from top go rish bottom.
MAR 15:39 Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”
MAR 15:40 Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama.
MAR 15:41 For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
MAR 15:42 Wen evening don rish for di day before di Sabat Day,
MAR 15:43 Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body.
MAR 15:44 Pilate sopraiz sey Jesus don die. So e koll di soja kon ask am weda e don tey wen Jesus die.
MAR 15:45 Wen Pilate hear wetin di soja tok, e kon sey make Josef go karry di body.
MAR 15:46 Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout.
MAR 15:47 Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.
MAR 16:1 Wen Sabat Day don pass, Mary Magdalin, Mary wey bi James and Salome mama kon buy some tins wey dey send well-well, make dem go rub am for Jesus body, make e nor for smell.
MAR 16:2 For early morning on Sunday, as sun just dey kom out, dem kon go di place wey dem beri Jesus put.
MAR 16:3 Dem kon dey ask each oda as dem dey go sey, “Who go help us roll di stone komot from di grave mout?”
MAR 16:4 But wen dem look, dem si sey, dem don already roll di stone komot.
MAR 16:5 As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.
MAR 16:6 But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.
MAR 16:7 Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
MAR 16:8 Di wimen kom out kon run from di grave side, bikos dem sopraiz and fear dey katch dem. Dem nor fit tell anybody anytin, bikos dem still dey fear.
MAR 16:9 [For early morning on Sunday, afta Jesus don wake-up, e first appear to Mary Magdalin wey e drive seven demon komot for en body.
MAR 16:10 For where di pipol wey dey follow Jesus dey mourn and kry dey, Mary Magdalin kon go tell dem wetin happen.
MAR 16:11 Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive.
MAR 16:12 Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.
MAR 16:13 Dem go back go tell di rest pipol, but di pipol nor still bilive dem.
MAR 16:14 Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
MAR 16:15 Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody.
MAR 16:16 Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
MAR 16:17 Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;
MAR 16:18 dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
MAR 16:19 Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.
MAR 16:20 Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.]
LUK 1:1 Many pipol don rite di story about di tins wey happen among us,
LUK 1:2 as di pipol wey si dem wen dem happen, tell us.
LUK 1:3 My oga Teofilus, since I follow evritin from biginnin, I kon tink am sey e good make I rite wetin really happen give yu,
LUK 1:4 so dat yu go undastand di tins wey dem tish yu well-well.
LUK 1:5 For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family.
LUK 1:6 Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.
LUK 1:7 Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.
LUK 1:8 E kom rish Zekaraya family turn to do priest work for di temple
LUK 1:9 and as dia custom bi, dem kon choose Zekaraya make e enter inside God Temple go burn incense.
LUK 1:10 Wen di time to burn incense don rish, all di pipol kon gada for outside dey pray.
LUK 1:11 God angel appear to Zekaraya for di altar side near where dem for dey burn incense.
LUK 1:12 As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake.
LUK 1:13 But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’
LUK 1:14 Di pikin go bring joy and happiness for yu and many pipol go happy well-well wen dem born am,
LUK 1:15 bikos God go use am well-well. E nor go drink wine or strong drink, but di Holy Spirit go dey inside am, even before dem go born am.
LUK 1:16 E go make many pipol follow God.
LUK 1:17 E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”
LUK 1:18 Zekaraya ask di angel, “How I go take know sey wetin yu tok so go happen? Bikos mi and my wife don old well-well.”
LUK 1:19 Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News.
LUK 1:20 But since yu nor bilive wetin I tok so, yu nor go fit tok again, until di day wen dis tins go happen.”
LUK 1:21 So di pipol wey dey wait for Zekaraya kon bigin wonder why e stay tey inside di temple.
LUK 1:22 Wen e kom outside, e nor fit tok again. Dem kon know sey e don si vishon for inside di temple, bikos e use hand take make sign for dem.
LUK 1:23 Wen en time to work inside di temple finish, e kon go house.
LUK 1:24 Wen e don tey small, Elizabet, wey bi Zekaraya wife kon get belle and e kon hide ensef inside house for five monts.
LUK 1:25 So Elizabet kon sey, “God don do big tin for mi for my old age, E don favor mi for pipol present and E don komot shame for my face.”
LUK 1:26 Wen Elizabet belle don rish six monts, God kon send angel Gabriel go Nazaret, one small town for Galilee,
LUK 1:27 go meet Mary. Dis Mary neva ever sleep with man before and na-im Josef wey kom from David family, won marry.
LUK 1:28 Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”
LUK 1:29 But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.
LUK 1:30 Den di angel tell am, “Make yu nor fear, Mary, bikos God don favor yu!
LUK 1:31 Make yu listin, yu go get belle kon born boy and yu go name am, ‘Jesus.’
LUK 1:32 E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.
LUK 1:33 Na-im go rule Jakob house forever and en kingdom nor go ever end.”
LUK 1:34 Mary tell di angel, “How dis tins go fit happen, as e bi sey I neva sleep with man before?”
LUK 1:35 Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.
LUK 1:36 Si, yor kousin Elizabet don get belle for six monts naw and e go born boy for en old age, even doh dem tok sey e nor go fit get belle.
LUK 1:37 Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”
LUK 1:38 Mary kon sey, “Yes, I bi God savant, make wetin yu tok so, happen to mi.” Den di angel kon leave am.
LUK 1:39 Afta two days, Mary kon get up rush go Judah
LUK 1:40 and e enter Zekaraya house go greet Elizabet.
LUK 1:41 Wen Elizabet hear as Mary dey greet am, di pikin for en belle jump and di Holy Spirit kon enter Elizabet body.
LUK 1:42 So Elizabet kon sey, “God don bless yu pass evry woman and E don bless di pikin wey dey yor belle!
LUK 1:43 Who I bi wey make my Oga God mama kom visit mi?
LUK 1:44 Bikos as yor greetin rish my ear, di pikin wey dey my belle kon happy bigin jump.
LUK 1:45 And God don bless yu, bikos yu bilive sey wetin E tok, go happen.”
LUK 1:46 Mary kon sey, “My heart go praiz God
LUK 1:47 and my spirit dey happy bikos God, my Savior,
LUK 1:48 don si en savant kondishon. From today go, evribody go sey God don bless mi,
LUK 1:49 bikos E don do big-big tins for mi and en name dey holy.
LUK 1:50 E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.
LUK 1:51 E don do many big-big tins with en pawa and E don skata di mind of di pipol dey karry body up.
LUK 1:52 E don remove rulers from dia throne and pipol wey bring demsef down, E don karry dem go up.
LUK 1:53 E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well, E don make dem poor.
LUK 1:54 E help en savants, Israel pipol remember en mesi,
LUK 1:55 wey E promise awa grand-grand papa dem and E go show mesi to Abraham and en shidren forever.”
LUK 1:56 Mary stay with Elizabet for about three monts, den e kon go back to en house.
LUK 1:57 Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy.
LUK 1:58 En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.
LUK 1:59 Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am, won kon gi-am en papa name, Zekaraya.
LUK 1:60 But en mama sey, “No, dem must koll am John.”
LUK 1:61 Dem kon sey, “But e nor get any of una relashon wey en name bi John.”
LUK 1:62 So dem make sign give Zekaraya ask sey, “Wetin wi go koll di pikin.”
LUK 1:63 Zekaraya ask for sometin make e rite put, den e kon rite, “En name na John.” So, all of dem kon sopraiz well-well.
LUK 1:64 Den Zekaraya mout open and e kon bigin praiz God.
LUK 1:65 Fear katch all dia neighbour and for evriwhere for Judea, na di matter dem kon dey tok about.
LUK 1:66 So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.
LUK 1:67 Den di Holy Spirit enter Zekaraya and e kon bigin profesai, dey sey,
LUK 1:68 “Make wi praiz Israel God, bikos E don help and free en pipol.
LUK 1:69 E send di Savior wey get pawa kom meet us, from David family.
LUK 1:70 God promise en profet before-before
LUK 1:71 sey, wi go dey save from awa enemy and from pipol wey hate us.
LUK 1:72 E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem and to remember di promise wey E give dem.
LUK 1:73 Even awa papa Abraham sey,
LUK 1:74 ‘E go save us from awa enemy hand, so dat wi go fit take all awa heart serve am
LUK 1:75 and wi go dey holy and good for en eye as long as wi dey for dis world.’
LUK 1:76 And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet and na yu go-go prepare di road for di Oga God,
LUK 1:77 wey go make pipol know sey, God go save dem, bikos E go forgive dem dia sins.
LUK 1:78 Since God love and en kindness strong well-well, E go let en salvashon rish us,
LUK 1:79 so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness and where deat dey. Den God go give us peace.”
LUK 1:80 Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.
LUK 2:1 Dat time, Caesar Augustus kon give orda make evribody wey dey Rome go register dia name make dem for pay tax.
LUK 2:2 Dis na di first time wey pipol go register, since di time wen Kwirinus bi govnor for Siria.
LUK 2:3 Evribody kon go en home-town go register.
LUK 2:4 So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom.
LUK 2:5 Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda.
LUK 2:6 As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born.
LUK 2:7 So e born en first son, wrap am kon put am for where dem dey keep animal, bikos know oda place dey for dem to stay.
LUK 2:8 Some shepads dey for dat aria, dey kare for dia sheep for nite.
LUK 2:9 God angel appear to dem and God glory kon dey shine for evriwhere, den fear katch dem.
LUK 2:10 Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy.
LUK 2:11 Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God.
LUK 2:12 Na dis go bi sign wey una go take know am: Una go si pikin wey dem use klot wrap inside where dem dey keep animal.”
LUK 2:13 At wons, many angels appear for heaven kon stand with di first angel dey praiz God sey,
LUK 2:14 “Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”
LUK 2:15 Wen di angels go back to heaven, di shepads kon tell each oda, “Make wi go Betlehem go si wetin happen, wey God don show us so.”
LUK 2:16 Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for inside di animal house.
LUK 2:17 Wen dem si am, dem kon tok how di angel take tell dem about di pikin.
LUK 2:18 Evribody wey hear wetin dem tok, sopraiz well-well.
LUK 2:19 But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.
LUK 2:20 So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi.
LUK 2:21 Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am kon koll am, “Jesus”, di name wey di angel tok before en mama even get belle.
LUK 2:22 Wen time rish for Mary to present ensef to God, as Moses Law tok, Josef and Mary kon karry Jesus go Jerusalem, go dedikate am give God,
LUK 2:23 (as dem rite am for God word, “Evry first-born wey bi boy, dem go gi-am to Mi”),
LUK 2:24 and dem go offa sakrifice with two dove or pijin.
LUK 2:25 One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
LUK 2:26 Di Holy Spirit don show am sey e nor go die before e go si di Mezaya wey God promise.
LUK 2:27 So God Spirit karry Simeon enter di temple and wen Jesus papa and mama bring am to do wetin Moses Law tok,
LUK 2:28 Simeon kon karry Jesus for en hand dey praiz God sey,
LUK 2:29 “Naw, as yor word tok, yu, God wey dey rule evritin, make yu let yor savant go rest.
LUK 2:30 Bikos my eye don si di pesin wey yu won make e save Israel pipol,
LUK 2:31 di One wey yu don prepare for evribody present:
LUK 2:32 Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.”
LUK 2:33 So di pikin papa and mama sopraiz for wetin Simeon tok about am.
LUK 2:34 Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.
LUK 2:35 True-true, bikos of am, di sekret tins for many pipol mind go kom out and vexnashon like swod, go shuk dia heart!”
LUK 2:36 One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die.
LUK 2:37 E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite.
LUK 2:38 For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
LUK 2:39 So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee.
LUK 2:40 Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
LUK 2:41 Evry year, Jesus papa and mama dey go Jerusalem for Passova Feast.
LUK 2:42 Wen Jesus bi twelf years, dem kon go as dem dey do before
LUK 2:43 and as dem dey go back to dia house, Jesus nor follow dem, but en papa and mama nor know;
LUK 2:44 bikos dem tink sey e dey among dem wey dey travel togeda. Wen dem don travel for one full day, dem kon dey find Jesus among dia rilashons and friends.
LUK 2:45 As dem nor si am, dem kon go back to Jerusalem go find am.
LUK 2:46 Afta three days, dem kon si am inside di temple, where e sidan with di tishas dey listin and dey ask dem many kweshon.
LUK 2:47 Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.
LUK 2:48 Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”
LUK 2:49 Jesus ansa dem, “Why una dey find mi? Una nor know sey I go dey my Papa house?”
LUK 2:50 But en papa and mama nor undastand wetin Jesus mean.
LUK 2:51 Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.
LUK 2:52 Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
LUK 3:1 Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.
LUK 3:2 For dat time, na Annas and Kaiafas bi di High Priests. So God kon tok to John, wey bi Zekaraya pikin, for inside wildaness.
LUK 3:3 John kon go all di aria wey dey round Jordan River dey prish sey make pipol turn from dia sin kom meet God and make dem baptize, so dat God go forgive dem.
LUK 3:4 As Profet Isaya tok for di book wey e rite sey, “One vois dey shaut for inside wildaness sey: ‘Prepare di way for di Oga God and make en road strait.
LUK 3:5 Evry place wey low, God go make am high and evry place wey high, God go make am low, bend-bend road go strait, di road wey bad, go good
LUK 3:6 and evribody for dis world go si God salvashon.’ ”
LUK 3:7 So John tell di pipol wey kom make e for baptize dem sey, “Una wey bi snake shidren! Who warn una make una run komot from God ponishment wey dey kom?
LUK 3:8 Naw, make una bear fruit wey go show sey una don really turn from sin kom meet God, make una nor start to sey, ‘Abraham na awa papa.’ Bikos God fit take dis stones wey dey for groun take make pikin for Abraham!
LUK 3:9 Even naw sef, di axe don ready to kut di tree wey nor dey bear betta fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.”
LUK 3:10 So di pipol kon ask am, “Wetin wi go do naw?”
LUK 3:11 John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”
LUK 3:12 Tax kollectors too waka kom make John for baptize dem and dem kon ask am, “Tisha, wetin wi go do?”
LUK 3:13 John tell dem, “Make una nor kollect money pass di one wey di law tok.”
LUK 3:14 Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
LUK 3:15 All di pipol kon dey wonder weda John, naim bi di Mezaya wey dem dey wait for.
LUK 3:16 John ansa dem, “Na ordinary wota I take dey baptize una, but di pesin wey big pass mi, dey kom, I nor rish who go luz di rope wey dey en shoe. E go baptize una with di Holy Spirit and fire.
LUK 3:17 E whole shovel for hand to harvest di korn keep for en store, but e go burn di korn kanda with fire wey nor dey kwensh.”
LUK 3:18 Na so John prish di Good News for di pipol.
LUK 3:19 But wen John tell Herod wey bi govnor sey, God dey vex with am, bikos of en broda wife, Herodias, wey e marry and all di bad-bad tins wey e do,
LUK 3:20 Herod take all dis join di vexnashon wey e get for John, so e kon lock am for prison.
LUK 3:21 So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open,
LUK 3:22 di Holy Spirit kom down for en head like dove. Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi my Pikin wey I love well-well and yu dey make belle sweet mi.”
LUK 3:23 Jesus start en ministry wen e bi thirty years. Evribody know am as Josef pikin, wey Heli born.
LUK 3:24 Heli na Mattat pikin, wey Levi born. Levi na Melchi pikin, wey bi Jannai pikin and na Josef bi Jannai papa.
LUK 3:25 Josef na Mattatias pikin wey bi Amos pikin, wey bi Nahum pikin, wey bi Esli pikin, wey bi Naggai pikin.
LUK 3:26 Naggai na Maat pikin, wey bi Mattatias pikin, wey bi Semein pikin, wey bi Josek pikin, wey bi Joda pikin.
LUK 3:27 Joda na Joanan pikin, wey bi Rhesa pikin, wey bi Zerubabel pikin, wey bi Shealtiel pikin, wey bi Neri pikin.
LUK 3:28 Neri na Melchi pikin, wey bi Addi pikin, wey bi Kosam pikin, wey bi Elmadam pikin, wey bi Er pikin.
LUK 3:29 Er na Joshua pikin, wey bi Elieza pikin, wey bi Jorim pikin, wey bi Mattat pikin, wey bi Levi pikin.
LUK 3:30 Levi na Simeon pikin, wey bi Judah pikin, wey bi Josef pikin, wey bi Jonam pikin, wey Eliakim born.
LUK 3:31 Eliakim na Melea pikin, wey bi Menna pikin, wey bi Mattata pikin, wey bi Natan pikin, wey bi David pikin.
LUK 3:32 Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.
LUK 3:33 Amminadab wey bi Admin pikin, naim born Nashon. Admin papa na Arni, wey bi Hezron pikin, wey bi Perez pikin wey Judah born.
LUK 3:34 Jakob wey Isaak born, naim bi Judah papa. Abraham born Isaak and na Terah wey Nahor born, bi Abraham papa.
LUK 3:35 Nahor na Serug pikin, wey bi Reu pikin, wey bi Peleg pikin, wey bi Eber pikin, wey bi Shela pikin.
LUK 3:36 Kainan wey Arfaxad born, naim bi Shela papa. Arfaxad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.
LUK 3:37 Lamek na Metuselah pikin, wey bi Enoch pikin, wey bi Jared pikin and Mahalalel wey Kenan born, naim bi Jared papa.
LUK 3:38 Kenan na Enosh pikin, wey bi Seth pikin, wey bi Adam pikin and na God kreate Adam.
LUK 4:1 Di Holy Spirit enter Jesus body kon karry am from Jordan River go inside wildaness.
LUK 4:2 For der, devil kon tempt am for forty days. Dat time, Jesus dey fast, so e nor chop food, but afta e fast finish, e kon dey hongry.
LUK 4:3 Devil kon tell am, “If na true sey yu bi God Pikin, make yu kommand dis stone make e turn to food.”
LUK 4:4 Den Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man suppose to chop for dis world, but na evry word wey God tok.’ ”
LUK 4:5 Den devil take Jesus go on-top one mountin kon show am all di kingdom wey dey dis world.
LUK 4:6 Den e tell am, “I go give yu all dis place and all di honor wey follow am as yor kingdom, bikos dem don gi-am to mi and I fit gi-am to anybody wey I wont.
LUK 4:7 So, if yu bow down woship mi, I go give yu evritin.”
LUK 4:8 Jesus ansa, “God word sey, ‘Na only God yu must woship and serve.’ ”
LUK 4:9 Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down,
LUK 4:10 bikos God word sey, “ ‘God go tell en angels make dem guide yu’
LUK 4:11 and, ‘Dem go karry yu for dia hand, so dat yu nor go use yor leg nak stone.’ ”
LUK 4:12 Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor test God wey bi yor Oga God.’ ”
LUK 4:13 So wen devil don tempt Jesus finish, e kon leave am until anoda time.
LUK 4:14 As di Holy Spirit pawa full Jesus body, e kon go back to Galilee and en story bigin spread for di whole aria.
LUK 4:15 E bigin tish for dia sinagog and evribody kon dey praiz God.
LUK 4:16 Afta, Jesus go Nazaret where e for grow up, e enter di sinagog for Sabat Day as e dey always do and e kon get up make e read.
LUK 4:17 Dem gi-am di book wey Profet Isaya rite. Jesus kon open am rish di place wey dem rite sey,
LUK 4:18 “God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress
LUK 4:19 and make I announce sey di time wen God won save en pipol, don rish.”
LUK 4:20 Jesus klose di book kon gi-am back to di pesin wey dey hold am, den e go sidan. So evribody wey dey di sinagog kon dey look am.
LUK 4:21 Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”
LUK 4:22 Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”
LUK 4:23 Jesus tell dem, “I know sey una go kwote proverb for mi sey, ‘Doctor, make yu cure yorsef!’ And una go sey, ‘For here wey bi yor home-town, wi won make yu do wetin wi hear sey yu do for Kapanaum.’ ”
LUK 4:24 Jesus still sey, “Make I tell una true word, profet nor dey get respet for en home-town.
LUK 4:25 But I tell una di trut, wimen wey dia husband don die many for Israel for Elijah time, wen God stop rain for three and half years and betta honga kon dey evriwhere.
LUK 4:26 But God nor send Elijah go meet any of doz wimen, escept one woman wey en husband die for Zarefat inside Sidon.
LUK 4:27 Pipol wey get leprosy many for Israel for profet Elisha time, but God nor heal any one escept Naaman, wey kom from Siria.”
LUK 4:28 Wen dem hear dis tins, all di pipol for di sinagog kon dey vex.
LUK 4:29 Dem push Jesus komot from di town kon take am go di hill wey dia town dey on-top, make dem for trow am down.
LUK 4:30 But Jesus pass dia centre, waka komot.
LUK 4:31 So Jesus kon go Kapanaum, wey dey Galilee and e bigin tish pipol for Sabat Day.
LUK 4:32 Dem sopraiz well-well for en tishing, bikos e dey tok with authority.
LUK 4:33 Inside di sinagog, one man wey evil spirit dey en body kon dey shaut,
LUK 4:34 “Abeg, make yu leave us alone, Jesus wey kom from Nazaret! Yu don kom distroy us? I know who yu bi, yu bi God savant wey holy.”
LUK 4:35 But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.
LUK 4:36 Di pipol sopraiz kon dey ask each oda, “Wetin dey happen so? Dis man dey use God pawa take kommand demon and dem dey obey am!”
LUK 4:37 So di news about Jesus kon spread enter di whole aria for Galilee.
LUK 4:38 Afta Jesus komot for di sinagog, e enter Simon house. Simon wife mama get fever and dem kon beg Jesus make e heal am.
LUK 4:39 So Jesus stand near di woman kon kommand di fever komot for en body. Kwik-kwik, di woman get up, bigin kare for Jesus and di odas wey dey di house.
LUK 4:40 As day dey dark, evribody wey get pipol wey nor well kon bring dem kom meet Jesus. E tosh dem for head and dem kon well.
LUK 4:41 Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.
LUK 4:42 Wen day break, Jesus komot go one place where nobody dey. But pipol find am rish der and dem kon dey try to hold am make e nor for leave dem.
LUK 4:43 But Jesus tell dem, “I must prish dis Good News about God Kingdom give pipol wey dey oda towns, bikos na wetin God send mi kom do, bi dat.”
LUK 4:44 So e kontinue to prish for di sinagogs wey dey Judea.
LUK 5:1 Jesus stand near Gennesaret and pipol gada make dem for hear God word.
LUK 5:2 E si two kenu for di wotaside, but di Fisha men wey get dem, don kom down dey wosh dia net.
LUK 5:3 E enter inside one kenu wey bi Simon Pita own kon tell am make e push di kenu enter wota small. Den Jesus kon sidan dey tish di pipol from di kenu.
LUK 5:4 Wen e don tok finish, e kon tell Simon, “Push di kenu go where deep pass for di wota, make una for fit katch fish.”
LUK 5:5 Simon ansa, “Oga God, wi dey here from nite till day break and wi nor katch anytin. But as yu tok, wi go trow awa net inside wota.”
LUK 5:6 So, dem trow dia net inside wota and dem katch many fish sotey dia net kon start to tear.
LUK 5:7 So, dem kon do sign give di oda pipol wey dey follow dem work, make dem kom help dem. Wen dem put all di fish inside di two kenu, di kenu dem kon dey won sink.
LUK 5:8 Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.”
LUK 5:9 Pita and all di pipol wey dey with am sopraiz well-well wen dem si all di fish wey dem katch.
LUK 5:10 James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too. Den Jesus tell Simon Pita, “Make yu nor worry, from today go, na pipol yu go dey katch.”
LUK 5:11 So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotaside, dem leave evritin kon follow Jesus.
LUK 5:12 Wen Jesus dey for one town, one man wey get leprosy kom meet am. Wen di man si Jesus, e fall face groun kon beg am sey, “Oga God, if yu like to do am, yu go fit heal mi.”
LUK 5:13 So Jesus tosh di man kon sey, “I like to do am. ‘Oya! Make yor body klean naw!’ ” At wons, di leprosy komot for di man body.
LUK 5:14 Jesus tell di man, “Make yu nor tell anybody, but go show yorsef to di priest and pay di ofrin wey Moses kommand sey, pipol wey dia leprosy don komot for dia body go bring, so dat di priest go know sey yu don really well.”
LUK 5:15 But di news about Jesus kon spread pass before and many pipol kom meet am make dem for fit hear en word and make e for heal dem.
LUK 5:16 But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
LUK 5:17 One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.
LUK 5:18 Some men karry one man for bed wey nor fit waka, kom. Dem kon dey try to karry am enter di house kom meet Jesus,
LUK 5:19 but bikos pipol many, dem nor fit karry am pass, so dem kon open di zink for di housetop, drop di man with di bed small-small, till e rish Jesus front for di pipol centre.
LUK 5:20 Wen Jesus si how dia faith big rish, e kon tell di man, “My friend, I forgive yu all yor sins.”
LUK 5:21 So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”
LUK 5:22 Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef?
LUK 5:23 Wish one eazy to tok? ‘I forgive yu yor sin?’ or ‘Get up make yu waka?’
LUK 5:24 But make una for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sin, e kon tell di man wey nor fit waka, ‘I tell yu, get up, karry yor bed make yu dey go house.’ ”
LUK 5:25 At wons, di man kon get up for dia present, karry di bed wey e liedan put before kon dey praiz God as e dey go house.
LUK 5:26 Evribody for der sopraiz well-well. Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey, “Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”
LUK 5:27 Afta dis one, Jesus go out and e kon si one tax kollector sidan for where e for dey kollect tax, en name na Levi. Jesus kon tell am, “Make yu follow mi.”
LUK 5:28 Levi get up, leave evritin kon follow am.
LUK 5:29 Den Levi do party for en house bikos of Jesus, so many tax kollectors and oda pipol kom chop with dem for di party.
LUK 5:30 But di Farisee pipol and some law tishas kon dey vex for Jesus disciples sey, “Why una dey chop and drink with tax kollectors and sinnas?”
LUK 5:31 Jesus ansa dem, “Pipol wey well nor nid doctor, na only doz wey nor well, nid am.
LUK 5:32 I nor kom koll good pipol to turn from sin kom meet God, but na sinnas, I kom koll.”
LUK 5:33 Den some pipol tell Jesus, “John disciples dey fast and pray and di Farisee disciples dey do di same tin too, but yor disciples just dey chop and drink anyhow.”
LUK 5:34 So Jesus ansa dem, “Yu go fit sey make pipol wey kom marriage dey fast wen di man wey dey marry dey der?
LUK 5:35 But time dey kom wen di man wey dey marry nor go dey with dem, dat time, dem go fast.”
LUK 5:36 E still tell dem one parabol sey: “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, e go fit spoil di new klot and di new klot piece nor go mash di old one.
LUK 5:37 And nobody dey pour new wine inside old wine bag. If e do like dat, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go skata.
LUK 5:38 Instead, pipol suppose pour new wine inside new wine bag.
LUK 5:39 Nobody go like to drink new wine afta e don drink old wine. Bikos e go sey, ‘Na di old wine betta pass.’ ”
LUK 6:1 Jesus dey waka pass where dem plant korn put and en disciples kon plok some korn dey chop.
LUK 6:2 Some of di Farisee pipol kon sey, “Why una dey do wetin awa law tok sey make wi nor do for Sabat Day?”
LUK 6:3 Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men dey hongry?
LUK 6:4 E enter God house kon take di bread wey holy wey only priests suppose chop and en and en men chop am.”
LUK 6:5 So Jesus tell dem, “Na Man Pikin bi Sabat Day Oga God.”
LUK 6:6 For anoda Sabat Day, Jesus enter di sinagog dey tish. One man wey en rite hand don die dey der.
LUK 6:7 Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
LUK 6:8 But Jesus know wetin dem dey tink, so e kon tell di man wey en hand die, “Get up, make yu kom stand for here”, so di man get up, go stand near am.
LUK 6:9 Den Jesus ask dem, “E dey rite to do good for Sabat Day” or “to save or distroy anybody life?”
LUK 6:10 Afta Jesus look dem round, e kon tell di man, “Stresh yor hand out.” So di man stresh en hand and di hand kon well.
LUK 6:11 But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”
LUK 6:12 Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
LUK 6:13 Wen day break, Jesus koll en disciples kon choose twelf among dem wey e koll apostles:
LUK 6:14 Simon (wey bi Pita) and en broda Andru and James, John, Filip, Bartolomew
LUK 6:15 Matiu, Tomas, James (Afaeus pikin) Simon wey bi Zealot, (pesin wey dey fight for en kountry).
LUK 6:16 Judas (James pikin) and Judas Iskariot wey leta sell Jesus give en enemies.
LUK 6:17 Den Jesus kom down with en apostles kon stand for groun wey level. Many disciples from Judea, Jerusalem and all di small towns wey near Tyre and Sidon gada kon hear am dey prish and e heal doz wey nor well
LUK 6:18 and odas wey evil spirit dey worry.
LUK 6:19 Evribody dey try to tosh am, bikos pawa wey dey komot from en body, dey heal pipol.
LUK 6:20 Den Jesus look en disciples, tell dem, “Make una happy, una wey dey poor, bikos na una get God Kingdom.
LUK 6:21 Make una happy, una wey dey hongry, bikos una go beleful. Make una happy, una wey dey kry naw, bikos una go laf.
LUK 6:22 Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol bikos of Man Pikin, God go bless una
LUK 6:23 and una go dey happy for dat day. “Make una happy well-well, bikos di reward wey una go get for heaven, go big well-well. Na so dia grand-grand papa dem tok about di profets too.
LUK 6:24 “But curse dey una head, una wey get money well-well naw, bikos una don already get una reward.
LUK 6:25 Curse dey una head, una wey don ova beleful, bikos una go hongry. Curse dey una head, una wey dey laf naw, bikos una go kry well-well.
LUK 6:26 Curse dey una head, una wey pipol dey tok good tins about, bikos na so dia grand-grand papa dem tok about di fake profets too.
LUK 6:27 “But I dey tell una wey dey listin, ‘Make una love una enemy and do good to pipol wey hate una.’
LUK 6:28 Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow.
LUK 6:29 If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too.
LUK 6:30 Make una give evribody wey ask una for sometin and if anybody take wetin bi una own, make una nor ask for am back.
LUK 6:31 Make una do for pipol as una wont make dem do for una.
LUK 6:32 “If una love only di pipol wey love una, wetin go make God bless una? Even sinnas sef love doz wey love dem.
LUK 6:33 And if una do good for only doz wey dey do good for una, wetin go make God bless una? Even sinnas dey do di same tin too.
LUK 6:34 If una borrow pesin money wen una know sey e go fit pay una back, wetin go make God bless una? Sinnas sef dey borrow money give sinnas, so dat dem go pay dem back dia korrect money.
LUK 6:35 But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.
LUK 6:36 So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”
LUK 6:37 “Make una nor judge oda pipol, so dat God nor go judge una. Make una nor kondemn odas, so dat God nor go kondemn una. Make una forgive odas and God go forgive una.
LUK 6:38 Make una give pipol wey nor get and God go give una wetin really big, E go pak am well-well and di tins go ova full. God go pour all dis tins for una life. But na as una take give odas, na so God go take give una too.”
LUK 6:39 Jesus still tell dem anoda parabol, “Pesin wey blind nor dey fit show anoda blind man road, abi e go fit? No! If na so, dem two go fall inside gutta.
LUK 6:40 No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.
LUK 6:41 “Why yu dey look di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey yor own eye.
LUK 6:42 How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’
LUK 6:43 “Bikos betta tree nor dey bear bad fruit and know bad tree dey bear good fruit,
LUK 6:44 bikos na fruit wey tree bear, naim pipol dey take know di kind tree wey e bi. Pipol nor dey plok fig or grape from shuku-shuku tree.
LUK 6:45 Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
LUK 6:46 “Why una dey koll mi, ‘Oga God’ and una nor dey do wetin I tell una?
LUK 6:47 Anybody wey kom meet mi and listin to my word kon do am; I go show una wetin di pesin bi like.
LUK 6:48 E bi like man wey dey build house, wey dig groun kon lay di foundashon on-top strong rock. Wen big wota rush kom, e nor go fit shake di house, bikos dem build am for betta rock.
LUK 6:49 But di pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like man wey build house wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di house go fall skata.”
LUK 7:1 Afta Jesus tish di pipol all dis tins, e kon go Kapanaum.
LUK 7:2 For der, one Roman soja get one savant wey e like well-well, but di savant nor well and e nearly die.
LUK 7:3 Wen di soja hear about Jesus, e kon send some Jew eldas go meet am sey, make e kom heal en savant.
LUK 7:4 Wen dem si Jesus, dem beg am well-well sey, “E good make yu kom help am,
LUK 7:5 bikos e love awa pipol and e even build sinagog for us.”
LUK 7:6 So Jesus follow dem go. As Jesus near di house, di soja kon send some for en friends go meet am sey, “Oga God, nor trobol yorsef, bikos I nor big rish who yu go enter en house.
LUK 7:7 Na dis make mi nor waka kom meet yu, instead, make yu just give orda and my savant go well.
LUK 7:8 Bikos mi too get pipol wey big pass mi and I get di ones wey I big pass. If I tell one, ‘Go!’ E go-go and anoda one, ‘Kom!’ E go kom and if I tell my savant, ‘Do dis tin!’ E go do am.”
LUK 7:9 Wen Jesus hear dis, e sopraiz and belle sweet am, naim e look di pipol wey dey follow am kon tell dem, “I tell una true word, I neva si dis kind faith before, even for Israel.”
LUK 7:10 So, wen doz wey di soja send go back to di house, dem kon si sey di savant don well.
LUK 7:11 Afta, Jesus go one town wey dem dey koll Nain, en disciples with many pipol follow am.
LUK 7:12 Near di town gate, dem meet pipol dey karry one dead body go beri. Di man mama na widow and naim bi di woman only pikin, so plenty pipol from di town kon follow am.
LUK 7:13 Wen Jesus si di woman, e sorry for am kon tell am, “Make yu nor kry again.”
LUK 7:14 Den e waka go tosh di koffin and di men wey karry am kon stop. Jesus kon sey, “Yong man, get up!”
LUK 7:15 So di man get up kon start to tok. Jesus kon gi-am back to en mama.
LUK 7:16 Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”
LUK 7:17 Di news about Jesus spread round Judea and all di place wey near der.
LUK 7:18 John disciples kon tell John about di tins wey dey happen. So e koll two of en disciples
LUK 7:19 kon send dem go ask Jesus sey, “Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?”
LUK 7:20 Wen dem si Jesus, dem kon sey, “John di Baptist send us make wi ask sey, ‘Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?’ ”
LUK 7:21 For dat same time, Jesus heal many pipol wey get difren sickness, pipol wey get evil spirit and pipol wey nor fit si, kon dey si.
LUK 7:22 So, Jesus ansa dem, make una go tell John wetin una don si and hear: “Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka before, dey waka, pipol wey get leprosy, dia body don klean, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wake-up and even poor pipol, don hear di Good News.
LUK 7:23 God go bless pipol wey nor dey doubt mi.”
LUK 7:24 Wen John messenjas don go, Jesus kon bigin tok to di pipol about John: “Wetin una go find for inside wildaness? Na grass wey breeze dey blow?
LUK 7:25 Wetin una go out go si? Na man wey wear fine klot? No! Bikos pipol wey dey wear fine klot and dey enjoy life, na king palis dem dey stay.
LUK 7:26 Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
LUK 7:27 Dis na wetin dem rite about am, “ ‘I dey send my messenja go yor front, wey go-go prepare yor road for yu.’
LUK 7:28 I tell una true word, among all di pipol wey woman born, nobody big rish John di Baptist, but di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.”
LUK 7:29 (Naw, evribody wey hear dis tins, even di tax kollectors, know sey God dey do wetin dey rite, bikos John di Baptist, baptize dem.
LUK 7:30 But di Farisee pipol and di law tishas rijet wetin God plan for dem, bikos John nor baptize dem.)
LUK 7:31 How I won take tok about pipol wey dey for dis world naw?
LUK 7:32 Dem bi like shidren wey sidan for market dey tell each oda, “ ‘Wi play music for una, but una nor gri dance; wi sing beri song for una, but una nor gri kry.’
LUK 7:33 Wen John di Baptist kom, e nor chop food or drink wine, but una sey, ‘E get demon!’
LUK 7:34 But God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkard, na tax kollectors and sinnas bi en friend.’
LUK 7:35 But doz wey get wisdom, know sey evritin about am, na trut.”
LUK 7:36 One Farisee kon invite Jesus kom chop for en house, so Jesus enter di Farisee house kon sidan.
LUK 7:37 Den, wen one woman from dat town wey bi sina hear sey Jesus dey chop for di Farisee house, e kon bring one fine oil bottol, wey dey send well-well, kom.
LUK 7:38 E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.
LUK 7:39 Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”
LUK 7:40 Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin I won tell yu.” Simon kon sey, “Tisha, I dey listin.”
LUK 7:41 “E get one man wey get two savant wey dey owe am money, one dey hold am 5,000 and di oda one, five hundred.
LUK 7:42 Wen two of dem nor fit pay di money back, e kon sey make dem forget about di money. Afta dat, wish of dem go like di man pass?”
LUK 7:43 Simon ansa, “Na di one wey en money big pass.” Jesus kon tell am, “Wetin yu tok, korrect.”
LUK 7:44 Den Jesus look di woman kon ask Simon, “Yu dey si dis woman? I enter yor house, yu nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am.
LUK 7:45 Wen I enter yor house, yu nor kiss or greet mi as awa tradishon bi, but since I enter, dis woman neva stop to kiss my leg.
LUK 7:46 Yu nor pour oil for my head, but dis woman don anoint my leg with oil wey dey send well-well.
LUK 7:47 Make I tell yu, I don forgive dis woman en many sins, so en love don big well-well, but di pesin wey dem forgive small sin, en love go small.”
LUK 7:48 Den Jesus tell di woman, “I forgive yu all yor sins.”
LUK 7:49 But di pipol wey sidan dey chop with Jesus kon dey tell each oda, “Who bi dis man wey dey forgive sin?”
LUK 7:50 So, Jesus tell di woman, “Yor faith don save yu; make peace follow yu go.”
LUK 8:1 Afta sometaim, Jesus kon travel go all di town and village dey prish di Good News about God Kingdom. Di twelf apostles
LUK 8:2 and some wimen wey Jesus drive evil spirit and difren sickness komot for dia body, go with am: Mary (wey dem dey koll Magdalin), wey Jesus drive seven demon komot for en body,
LUK 8:3 Joanna, Shuza wife (wey bi managa for Herod house), Susanna and many oda wimen wey dey use dia own money support Jesus and en disciples.
LUK 8:4 Many pipol gada round Jesus and some still dey kom from difren place, so e kon tell dem dis parabol:
LUK 8:5 “One man go plant seed for en farm. As e dey plant, some fall for road, pipol mash dem pass and birds kon chop dem.
LUK 8:6 Some wey fall for where stones dey kon grow and die, bikos wota nor dey dat groun.
LUK 8:7 Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow, di shuku-shuku grow too, kon shuk dem die.
LUK 8:8 But di ones wey fall for betta groun, grow kon bear pass hundred seed.” Den Jesus sey, “Anybody wey get ear, make e hear!”
LUK 8:9 Den en disciples ask am wetin di parabol mean.
LUK 8:10 Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat “As dem dey look, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.
LUK 8:11 “Na wetin di parabol mean bi dis: Di seed na God word.
LUK 8:12 Di ones wey fall for road, na di pipol wey hear God word, but devil kon tif am from dia heart, so dat dem nor go bilive and God nor go save dem.
LUK 8:13 Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again.
LUK 8:14 Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.
LUK 8:15 But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”
LUK 8:16 “Pesin nor go lite kandol kon take bucket kover am or hide am under bed, but e go put am for where pipol go si am wen dem enter di house.
LUK 8:17 Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sekret naw, God go bring am out for where lite dey.
LUK 8:18 So make una listin well-well, bikos pesin wey get, God go gi-am more, but pesin wey nor get, even di small one wey e tink sey e get, God go take am from en hand.”
LUK 8:19 Jesus mama and en brodas kom meet am, but dem nor fit go near am, bikos pipol plenty for der.
LUK 8:20 So pipol tell am, “Yor mama and brodas dey outside, dem won si yu.”
LUK 8:21 Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”
LUK 8:22 One day, Jesus and en disciples enter kenu, den e tell dem, “Make wi cross go di oda side for di river.” So dem kon go.
LUK 8:23 As dia kenu dey move for di wota, Jesus dey sleep, den strong breeze start to blow and dem kon dey fear, bikos wota dey enter di kenu.
LUK 8:24 Dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!” Jesus get up kon kommand di breeze make e stop and di wota wey rof before, stop and evriwhere kon kwayet.
LUK 8:25 Den Jesus ask dem, “Where una faith dey?” But dem dey fear and sopraiz dey tell each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wota dey obey am!”
LUK 8:26 Dem kon rish Gerasenes aria wey face Galilee.
LUK 8:27 As Jesus kom down from di kenu, one man wey get demon for di town kom meet am. E don tey wen dis man wear klot or stay inside house, but e dey stay for beri groun.
LUK 8:28 Wen e si Jesus, e fall for en front kon shaut, “Make yu leave mi! Jesus, God Pikin, Abeg yu, nor ponish mi!”
LUK 8:29 E shaut, bikos Jesus don first kommand di evil spirit make e komot for en body (bikos di evil spirit don disturb di man well-well and dem dey shain and guide am. But e dey break di shain and di demon go drive am go inside wildaness.)
LUK 8:30 Jesus ask am, “Wetin bi yor name?” E ansa, “Na Legion, bikos wi plenty inside am.”
LUK 8:31 Di demons kon beg Jesus make e send dem go inside di river.
LUK 8:32 Near di river, many pig dey togeda dey chop and di evil spirits beg Jesus make dem enter inside di pigs. So Jesus allow dem.
LUK 8:33 Di demons komot for di man body go enter di pigs and all of dem rush enter di river go die.
LUK 8:34 Wen di pipol wey dey keep di pigs si wetin happen, dem run go inside town bigin spread di news.
LUK 8:35 So pipol run kom si wetin dey happen and dem meet Jesus for der. Di man wey Jesus drive demon komot for en body, don well and e wear klot sidan near Jesus leg, so fear kon katch di pipol.
LUK 8:36 Pipol wey si wetin happen, tell di town pipol how Jesus heal di man wey get demon before.
LUK 8:37 Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tell Jesus make e leave dem, bikos dem dey fear well-well. So Jesus and en disciples enter kenu kon komot for der.
LUK 8:38 Di man wey demon komot for en body beg Jesus make e follow am, but Jesus tell am,
LUK 8:39 “Make yu go yor house go tell dem wetin God don do for yu.” So di man kon go, dey tell pipol for di town wetin Jesus do for am.
LUK 8:40 Wen Jesus go back for di oda side for di river, pipol welkom am for der, bikos e don tey wey dem dey wait for am.
LUK 8:41 Den Jairus wey bi oga for di sinagog waka kom. E fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house,
LUK 8:42 bikos e only dota wey don rish twelf years, dey die. As Jesus dey go di man house, pipol kon dey waka jam am anyhow bikos dem plenty.
LUK 8:43 One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am.
LUK 8:44 E waka kom Jesus back kon tosh Jesus klot korna and at wons, di blood kon stop.
LUK 8:45 Den Jesus ask, “Na who tosh mi?” Wen evribody sey dem nor know, Pita kon tell Jesus, “Oga God, plenty pipol gada round yu and all of dem body dey tosh yu!”
LUK 8:46 But Jesus sey, “Somebody tosh mi, bikos pawa komot for my body.”
LUK 8:47 Wen di woman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fall for Jesus front. For evribody present, e tok wetin make am tosh Jesus and how e kon well at wons.
LUK 8:48 Jesus kon tell di woman, “My pikin, yor faith don heal yu. Make peace follow yu.”
LUK 8:49 As Jesus still dey tok, somebody run kom from Jairus house kon tell Jairus sey, “Yor pikin don die, so make yu nor worry di tisha again.”
LUK 8:50 But wen Jesus hear am, e tell Jairus, “Make yu nor fear, just bilive and yor pikin go well.”
LUK 8:51 Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama.
LUK 8:52 Evribody for der dey kry take body nak groun, but Jesus tell dem, “Make una nor kry, bikos di girl neva die, na sleep e dey sleep.”
LUK 8:53 Dem kon bigin laf am, bikos dem know sey di girl don die.
LUK 8:54 But Jesus whole di girl hand kon sey, “My pikin, get up.”
LUK 8:55 Naim di girl spirit enter di body back and e kon get up at wons. Den Jesus tell dem make dem give di pikin food chop.
LUK 8:56 Di papa and mama sopraiz well-well, but Jesus kommand dem make dem nor tell anybody wetin happen.
LUK 9:1 Afta Jesus don koll di twelf disciples togeda, e give dem pawa and authority to drive demon and to heal pipol wey nor well.
LUK 9:2 Den e kon send dem go prish about God Kingdom and heal pipol wey nor well.
LUK 9:3 E tell dem, “Make una nor take walkin stik, bag, bread, money or estra klot follow body.
LUK 9:4 Make una stay for any house wey una enter until una komot for dat aria.
LUK 9:5 Anywhere wey dem nor welkom una, make una shake di san from una leg as una dey komot and dis go bi witness against dem.”
LUK 9:6 Di disciples kon travel go all di village dem, dey prish di Good News and heal pipol for evriwhere.
LUK 9:7 Wen Herod wey bi ruler hear about evritin wey dey happen, e konfuse, bikos some pipol sey John don wake-up from deat
LUK 9:8 and odas sey Elijah don appear, some still sey one old profet don wake-up.
LUK 9:9 Herod kon sey, “I orda make dem kut John head komot, but who bi dis one wey I dey hear all dis tins about so?” Bikos of dat, Herod kon try to find out more about Jesus.
LUK 9:10 Wen di apostles kom back, dem tell Jesus evritin wey dem don do. Den Jesus take only dem follow body go Betsaida.
LUK 9:11 But wen pipol know, dem kon follow Jesus and en disciples go der. E welkom dem, den tell dem about God Kingdom and e heal doz wey nor well.
LUK 9:12 Wen day don dey dark, di disciples kon tell Jesus, “Tell dis pipol make dem go, so dat dem go-go di village and farm wey near dis aria go fine food chop kon sleep for der, bikos dis place na wildaness.”
LUK 9:13 But Jesus ansa, “Make una give dem food chop.” Dem kon sey, “Na only five bread and two fish wi get, unless yu wont sey make wi go buy food for all of dem.”
LUK 9:14 (Di men wey dey der alone rish 5,000). Jesus tell en disciples, “Tell di pipol make dem sidan fifty-fifty.”
LUK 9:15 Di disciples do as Jesus tok and all di pipol kon sidan.
LUK 9:16 Den Jesus take di five bread and two fish, e look heaven, tank God, den e kon divide dem. E give di bread and fish to en disciples, make dem share am for di pipol.
LUK 9:17 Evribody chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e full twelf basket.
LUK 9:18 As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
LUK 9:19 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”
LUK 9:20 Den Jesus ask dem, “But who una tok sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya wey God send.”
LUK 9:21 But Jesus warn dem well-well sey make dem nor tell anybody about am.
LUK 9:22 Den Jesus tell dem, “God Pikin go sofa many tins: di eldas, di priest oga dem and di law tishas go rijet am, dem go kill-am and afta three days, God go wake am up.”
LUK 9:23 So Jesus tell all of dem, “If pesin won follow mi, e must forget ensef, karry en cross evriday, dey follow mi.
LUK 9:24 Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi, go save am.
LUK 9:25 Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul?
LUK 9:26 Anybody wey dey shame for mi and my word, Man Pikin go shame for am wen e go kom back for en glory and di glory wey en Papa and di angels get.
LUK 9:27 But I tell una true word, some pipol wey stand for here nor go die, before dem go si God Kingdom.”
LUK 9:28 One week afta Jesus tok all dis tins, e kon take Pita, John and James go on-top one mountin go pray.
LUK 9:29 As e dey pray, en face shange and en klot kon dey shine like lite.
LUK 9:30 At wons, Moses and Elijah kon dey tok with am.
LUK 9:31 As dem appear with glory, dem kon tell Jesus how e go sofa and die for Jerusalem, as dem rite for God word.
LUK 9:32 Pita and di odas wey dey with am dey sleep before, but at wons sleep komot from dia eye and dem si Jesus glory and di two men wey stand with am.
LUK 9:33 Den as Moses and Elijah won go, Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” (Pita nor even know wetin e dey tok.)
LUK 9:34 As e still dey tok, one kind kloud surround dem, fear kon katch di disciples, as Moses and Elijah enter di kloud.
LUK 9:35 One vois from di kloud kon sey, “Dis na my pikin wey I choose. Make una listin to am!”
LUK 9:36 Afta di vois don tok finish, Jesus kon dey alone for di place, but di disciples kwayet and dem nor tell anybody wetin dem si.
LUK 9:37 Di next day wen dem kom down from di mountin, many pipol kom meet Jesus.
LUK 9:38 Den one man among di pipol kry kom, “Tisha, Abeg yu, si my pikin, na-im bi di only boy wey I get!
LUK 9:39 Evil spirit dey worry am and e dey make am shaut. Di spirit dey shake am and foam dey komot for en mout. Di spirit nor gri leave am and e dey trobol am well-well.
LUK 9:40 Abeg yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
LUK 9:41 Jesus kon tell dem, “Una wey dey do bad tins and nor gri bilive, how long I go stay with una?” Den e tell di man, “Bring yor pikin kom here.”
LUK 9:42 As di boy dey kom, di demon trow am for groun, e start to dey shake and foam kon dey komot from en mout. Den Jesus kommand di demon make e komot and e heal di boy, kon gi-am to en papa.
LUK 9:43 Den evribody wey dey der kon sopraiz as dem si God pawa. But as di pipol still dey sopraiz, Jesus kon tell en disciples,
LUK 9:44 “Make una nor forget wetin I won tell una, dem go sell God Pikin give human being.”
LUK 9:45 But dem nor undastand dis word, bikos God hide am from dem make dem for nor know wetin di word mean. Di disciples demsef dey fear to ask Jesus about di matter.
LUK 9:46 Di disciples kon dey ask demsef, “Who big pass among us for God Kingdom?”
LUK 9:47 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e bring one small pikin near am
LUK 9:48 kon tell dem, “Anybody wey welkom dis small pikin bikos of mi, don welkom mi and anybody wey welkom mi, don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey small pass among una, na-im big pass for God Kingdom.”
LUK 9:49 John tell Jesus, “Oga God, wi si one man dey drive demon with yor name and wi tell am make e stop, bikos e nor dey with us.”
LUK 9:50 Jesus kon ansa am, “Nor stop am, bikos anybody wey nor dey against us, dey awa side.”
LUK 9:51 Wen di time wey God go take Jesus go heaven don near, Jesus tink for en mind sey, e go-go Jerusalem.
LUK 9:52 E kon send messenjas go for front and dem enter one village for Samaria go prepare evritin before e go rish der,
LUK 9:53 but di villagers nor gri welkom am, bikos dem si sey, e won go Jerusalem.
LUK 9:54 Wen James and John si wetin happen, dem kon sey, “Oga God, yu wont make wi koll fire down from heaven kon kill dis pipol?”
LUK 9:55 But Jesus turn warn dem,
LUK 9:56 den en and dem kon go anoda village.
LUK 9:57 As Jesus dey go for road, one man kon tell am, “I won follow yu go anywhere wey yu dey go.”
LUK 9:58 Jesus kon tell am, “Rabbits get whole, birds get nest, but Man Pikin nor get anywhere to put en head!”
LUK 9:59 Jesus kon tell anoda man, “Make yu follow mi,” but dat one sey, “Oga God, make I first go beri my papa.”
LUK 9:60 Jesus kon tell am, “Make doz wey don die, beri who don die. But make yu go prish about God Kingdom.”
LUK 9:61 Anoda pesin kon sey, “Oga God! I go like to follow yu, but make I first go tell my family bye-bye.”
LUK 9:62 Jesus tell am, “Pesin wey put hand for dis work, den e kon dey look back, nor get part for God Kingdom.”
LUK 10:1 Afta, Jesus choose seventy-two men kon send dem two-by-two go all di town and oda place where e won go leta.
LUK 10:2 E tell dem, “Di fruit wey dem won plok, plenty, but pipol wey go plok dem, nor plenty rish. Make una pray make di Oga God wey get di farm send workers kon gada en fruit.
LUK 10:3 Make una go! I dey send una like small-small sheep go meet wiked animal.
LUK 10:4 Make una nor take bag or shoe and nor greet anybody for road.
LUK 10:5 “Wen una enter any house, make una first sey, ‘Make peace dey dis house!’
LUK 10:6 If anybody wey wont peace dey der, una peace go stay with am, but if e nor dey, una peace go kom back to una.
LUK 10:7 Make una stay for dat house, chop and drink anytin wey dem give una, bikos anybody wey dey work, suppose to get en pay. Make una nor dey waka from one house go anoda.
LUK 10:8 “Wen una enter any town and dem welkom una, make una chop di food wey dem give una
LUK 10:9 and heal di pipol wey nor well for dat town, den tell di pipol wey dey der sey, ‘God Kingdom don kom meet una.’
LUK 10:10 But wen una enter any town and dem nor welkom una, make una go road kon sey,
LUK 10:11 ‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’
LUK 10:12 I tell una true word, e go betta for Sodom for judgement day pass dat town!
LUK 10:13 “Korazin and Betsaida pipol, curse dey una head! Bikos if to sey na for Tyre and Sidon dem for do di mirakles wey dem do for una town, di pipol der for don turn from sin kom meet God since, dem for don sidan, wear sack-klot and put ashes for dia head kon dey beg God make E forgive dem.
LUK 10:14 But e go betta for Tyre and Sidon pipol pass una for judgement day!
LUK 10:15 Una Kapanaum pipol, una tink sey God go just karry una go heaven? No, E go trow una for hell-fire.”
LUK 10:16 Jesus tell en disciples, “Anybody wey listin to una, don listin to mi and anybody wey rijet una, don rijet mi and God wey send mi.”
LUK 10:17 Di seventy-two men kon kom back with happiness, dey sey, “Oga God, even demons dey obey us wen wi kommand dem with yor name!”
LUK 10:18 Jesus tell dem, “I si Satan wen e fall like tunda-lite from heaven.
LUK 10:19 Make una listin, I don give una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ovakom all di enemy pawa, so nor-tin go fit wound una.
LUK 10:20 Make una nor only dey happy sey evil spirit dey obey una, instead make una happy sey God rite una name for heaven.”
LUK 10:21 For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.
LUK 10:22 “My Papa don give mi evritin. Nobody know who di pikin bi escept di Papa and nobody know who di Papa bi escept di pikin and pipol wey di pikin choose to show.”
LUK 10:23 Den Jesus kon face en disciples tell dem small-small, “God don bless di pesin wey en eye si wetin una dey si so-o-o!
LUK 10:24 I tell una true word, ‘Many profets and kings don try to si wetin una dey si so, but dem nor fit si am and dem don won hear wetin una dey hear so, but dem nor fit hear am.’ ”
LUK 10:25 One man wey sabi di law well-well kon get up test Jesus, “Tisha, wetin I go do to take get life wey nor dey end?”
LUK 10:26 Jesus kon ask am, “Wetin yu undastand about Moses Law?”
LUK 10:27 Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”
LUK 10:28 Jesus kon tell am, “Yor ansa korrect, make yu do dem and yu go get korrect life.”
LUK 10:29 But di man won show sey en know well-well, so e kon ask Jesus, “Who bi my neighbour?”
LUK 10:30 Jesus tell am dis story, “One man dey travel from Jerusalem go Jeriko and tif kon attack am for road, dem naked am, beat am till e nearly die, den kon waka leave am.
LUK 10:31 Afta, one priest dey pass der, wen e si di man, e waka pass for di oda side for di road.
LUK 10:32 Na so too, one worker for di temple still waka rish where di man dey, but e waka pass di oda side for di road.
LUK 10:33 But one Samaria man wey dey travel for dat road kon rish where di man dey, as e si di man, e sorry for am.
LUK 10:34 E waka go meet di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kare for am dat nite.
LUK 10:35 Di next day, di Samaria man give di hotel manaja two silva koins kon tell am, ‘Make yu kare for dis man, wen I kom back, I go pay yu any estra money wey yu spend.’ ”
LUK 10:36 Jesus kon ask di man wey e dey follow tok sey, “Among dis three men, wish one yu tink sey bi neighbour to di man wey tif attack?”
LUK 10:37 Di man wey sabi di law well-well kon ansa, “Na di one wey kare for di man.” So, Jesus kon tell am, “Make yu go do di same tin too.”
LUK 10:38 As Jesus and en disciples still dey travel, dem rish one village and one woman wey en name bi Marta kon welkom dem for en house.
LUK 10:39 Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jesus leg dey listin to wetin e dey tish.
LUK 10:40 But Marta nor happy, bikos of all di work wey e dey do, so e meet Jesus kon sey, “Oga God! Si, my sista don leave all di work for mi. Abeg, tell am make e kom help mi.”
LUK 10:41 Jesus ansa am, “Marta! Marta! Yu dey too wahala yorsef about many tins,
LUK 10:42 na only one tin dey important and Mary don choose di korrect tin and nobody go fit take am from am.”
LUK 11:1 One day Jesus dey pray for one place. Wen e pray finish, one of en disciples kon tell am, “Oga God! Make yu tish us how to pray, just as John tish en disciples.”
LUK 11:2 So Jesus tell dem, “Wen una dey pray, make una sey: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi greet yu, Make yor kingdom kom.
LUK 11:3 Give us di bread wey wi go chop today,
LUK 11:4 Make yu forgive us awa sins, as wi dey forgive doz wey do us bad. Nor let us enter temptashon.’ ”
LUK 11:5 Den Jesus tell dem, “Like sey one of una go meet en friend for mid-nite sey, ‘My friend, abeg give mi three bread,
LUK 11:6 bikos one of my friend wey dey travel stop for my place and I nor get anytin to gi-am chop.’
LUK 11:7 “Den yor friend kon ansa from inside house, ‘Make yu nor disturb mi. I don lock my door and mi and my shidren dey sleep. I nor go fit get up give yu anytin naw.’
LUK 11:8 I tell yu true word, even if di man inside, nor won get up bikos yu bi en friend, e go get up give yu anytin wey yu wont, bikos yu nor let am rest.
LUK 11:9 “So, I tell yu true word: Make yu ask and God go give yu, find and yu go si wetin yu dey look for, make yu nok and di door go open for yu.
LUK 11:10 Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey find, go si wetin e dey find and di pesin wey nok, di door go open for am.
LUK 11:11 “Wish of una wey bi papa go give en pikin snake, if e ask for fish?
LUK 11:12 Or if di pikin ask for egg, una go gi-am skorpion?
LUK 11:13 Since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa for Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”
LUK 11:14 One day, Jesus kon drive demon wey dey make pesin nor fit tok komot for one man body. Wen di demon don komot, di man bigin tok and di pipol sopraiz well-well.
LUK 11:15 But some among dem sey, “Belzibub wey bi demon oga, na en pawa Jesus dey use take drive demons.”
LUK 11:16 But oda pipol kon dey ask for sign from heaven, bikos dem won test Jesus.
LUK 11:17 Jesus know wetin dey dia mind, so e tell dem, “Any kingdom where pipol dey fight each oda nor go last and family wey divide, go fall.
LUK 11:18 So, if Satan kingdom divide, how en kingdom go take last? I dey ask una dis tin, bikos una dey sey na Belzibub pawa I take dey drive demons.
LUK 11:19 If na Belzibub pawa I take dey drive demons, den na wish pawa una pikin dem dey use? So, na una pikin go judge una.
LUK 11:20 But if na God pawa I take dey drive demon komot, den God Kingdom don rish where una dey.
LUK 11:21 “Wen pesin wey get pawa ready well-well guide en own house, all en tins go dey save.
LUK 11:22 But wen pesin wey get pawa pass am attack and win am, di pesin go karry all di tins wey di man take dey protet ensef kon divide di propaty wey remain.
LUK 11:23 “Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor dey work with mi, dey work against mi.
LUK 11:24 “Wen evil spirit komot for pesin body, e go dey waka anyhow, dey fine where e go rest. But wen e nor si, e go tell ensef, ‘Make I go back to di house wey I from komot.’
LUK 11:25 But wen e kom back, kon si sey dem don swip evriwhere klean, arrange am and nobody dey der,
LUK 11:26 e go-go bring seven oda spirits wey wiked pass am join ensef and dem go stay for der, so di pesin kondishon go worse pass as e bi before.”
LUK 11:27 As Jesus tok dis tins, one woman for der kon shaut, “God go bless di belle wey born yu and di breast wey yu sok!”
LUK 11:28 Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”
LUK 11:29 As pipol dey plenty more-more, Jesus kon sey, “Pipol wey dey dis world naw wiked well-well; dem dey look for sign, but God nor go show dem any sign, escept di tin wey happen for Jonah time.
LUK 11:30 Just as Jonah bi profet for Nineveh pipol, na so Man Pikin go bi sign for di pipol wey dey dis world naw.
LUK 11:31 For Judgement Day, Sheba Kween go bear witness against pipol wey dey dis world naw and God go kondemn dem, bikos di kween travel from far place kom hear di wise tins wey Solomon tish. But naw, pesin wey big pass Solomon dey here!
LUK 11:32 For Judgement Day, na so too Nineveh pipol go bear witness against pipol wey dey dis world naw, bikos dem turn from sin kom meet God wen Jonah prish give dem. But naw, pesin wey big pass Jonah dey here.”
LUK 11:33 “Nobody dey lite lamp put for under basket or for where pipol nor go fit si am, but dem go put am for where pipol go si am wen dem enter di house.
LUK 11:34 Na eye bi di lamp wey body get. If yor eye well, lite go full yor whole body, but wen yor eye nor well, na darkness go full yor body.
LUK 11:35 So make sure sey wetin dey inside yu, na lite, nor bi darkness.
LUK 11:36 If lite full yor body and darkness nor dey inside at-all, e go shine well-well like wen lamp dey shine for yor face.”
LUK 11:37 As Jesus dey tok, one Farisee koll am kom en house kon chop, so Jesus go sidan for where dem go for chop.
LUK 11:38 Di Farisee sopraiz well-well wen e si sey Jesus nor first wosh-hand, before e bigin chop.
LUK 11:39 But Jesus tell am, “Una wey bi Farisee pipol dey wosh outside cup and plate, but inside una belle, long-trot and wikedness full am.
LUK 11:40 Una bi fool! Nor bi God wey make di outside still make inside?
LUK 11:41 But make una from una heart give to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klean for una.
LUK 11:42 “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipol! Una dey give God one out of evry ten tins wey una get! But una dey forget pipol wey nor get.
LUK 11:43 “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipol! Una dey won sidan for betta chair for sinagog and una dey like make pipol dey greet una for market.
LUK 11:44 “Curse dey una head! Una bi like grave wey pipol dey mash pass and dem nor know sey na grave.”
LUK 11:45 One man wey know di law well-well kon ansa, “Tisha, yu dey curse us as yu dey tok like dis so o-o.”
LUK 11:46 But Jesus ansa am, “Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una karry heavy load put for pipol back and una nor won even take hand tosh di load!
LUK 11:47 “Curse dey una head! Una dey build profets grave, di profets wey una grand-grand papa kill.
LUK 11:48 Dis show sey una support di tins wey una grand-grand papa dem do, bikos dem kill di profets and una build dia graves!
LUK 11:49 Na dis one make God tok with en wisdom sey, ‘I go send profets and apostles go meet dem and dem go sofa and kill some among dem.’
LUK 11:50 So di profets blood wey dem don kill since di world start, di pipol wey dey dis world naw, go take dia head karry am.
LUK 11:51 From wen dem kill Abel go rish di time wen dem kill Zekaraya for di altar inside di temple, dia blood dey dis pipol head and God go judge dem.
LUK 11:52 “Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”
LUK 11:53 Wen Jesus komot from der, di pipol wey know di law well-well and di Farisee pipol kon dey vex, so from dat time, dem kon bigin ask Jesus yeye kweshon about many tins
LUK 11:54 and dem kon dey plan, so dat dem go fit find word for en mout, wey dem go take hold am.
LUK 12:1 Plenty pipol gada around Jesus kon dey waka jam one anoda, so Jesus kon tell en disciples, “Make una shine una eye well-well, bikos of di Farisee pipol wey dey pritend.
LUK 12:2 Anytin wey pipol hide naw, go kom out for publik and anytin wey dey sekret naw, God go bring am out.
LUK 12:3 So anytin wey pesin do for darkness, go kom out for lite and anytin wey pesin tok for sekret, pipol go shaut am from on-top house.
LUK 12:4 “I tell una wey bi my friends, make una nor fear pipol wey fit kill pesin, but dem nor fit do pass dat.
LUK 12:5 But make I tell una who una must fear: Make una fear di Pesin wey get pawa to trow una inside hell-fire afta E don kill una. Yes, I tell una true word, na-im una must fear!
LUK 12:6 Nor bi two koins dem dey sell five sparo bird? But God nor dey forget any one among dem.
LUK 12:7 Si, God know di nomba of hair wey dey una head. So make una nor fear, bikos una betta pass many sparo bird.
LUK 12:8 “I tell una true word, anybody wey stand up for publik sey en know mi, mi too go stand up for am for where God angels dey.
LUK 12:9 But pesin wey rijet mi for where pipol dey, mi too go rijet am for where God angels dey.
LUK 12:10 And anybody wey tok bad about Man Pikin, God go fit forgi-am, but pesin wey tok bad about di Holy Spirit, God nor go forgi-am.
LUK 12:11 “Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok,
LUK 12:12 bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”
LUK 12:13 Den one pesin among di pipol kon sey, “Tisha, tell my broda make e divide di propaty wey awa papa die leave for us.”
LUK 12:14 But Jesus ask am, “My friend, na who make mi judge for una two matter?”
LUK 12:15 Den Jesus tell dem, “Make una guide against long-trot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am.”
LUK 12:16 So Jesus kon tell dem one parabol: “One rish man plok plenty food from en farm,
LUK 12:17 so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’
LUK 12:18 “Den di man sey, ‘I know wetin I go do: I go skata my stores kon build new big-big one wey I go keep all my food and oda tins wey I plok.
LUK 12:19 Den I go tell mysef, “Yu get plenty food wey go last yu for many years, so make yu go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” ’
LUK 12:20 “But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
LUK 12:21 “Na so e go bi with pesin wey dey gada money keep for ensef, but en heart nor dey with God.”
LUK 12:22 Jesus tell en disciples, “Naw I dey tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for body.
LUK 12:23 Bikos life good pass food and awa body betta pass klot.
LUK 12:24 Make una tink how birds bi: Dem nor dey plant or plok, dem nor get where dem dey keep food put, but God dey give dem food chop. If God dey kare for dem, wot about una wey betta pass dem?
LUK 12:25 Wish of una go fit add one hour join en life, bikos e dey worry?
LUK 12:26 So, if una nor fit do dis simpol tin, why una dey worry about di odas?
LUK 12:27 “Make una tink of how flowers dey grow: Dem nor dey work or make klot for demsef. But I tell una true word, even Solomon for all di glory wey e get, nor dress fine rish flowers!
LUK 12:28 If God dey dress flowers wey dey today and pipol go kut am trow for fire tumoro, dat God nor go fit kare for una? Una faith small well-well o-o!
LUK 12:29 Make una nor dey worry about wetin una go chop or drink.
LUK 12:30 Na bikos of all dis tins, pipol wey nor know God dey worry demsef, but una Papa for heaven know sey una nid dem.
LUK 12:31 Instead, make una first struggol to enter God Kingdom and God go give una all di oda tins.
LUK 12:32 “Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.
LUK 12:33 Make una sell evritin wey una get and give di money to poor pipol. Bag wey nor go tear, make una take am gada betta tins for heaven, where tif nor go fit rish and siti-siti nor go fit spoil dem.
LUK 12:34 Bikos na where yor propaty dey, na der yor heart go dey too.
LUK 12:35 “Make una ready to serve God and make una lite dey shine evritime.
LUK 12:36 Make una bi like pipol wey dey wait for dia oga to kom back from party, so dat wen e nok, una go kwik open door for am.
LUK 12:37 Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol.
LUK 12:38 Make doz savant happy well-well, even if di oga kom for nine or three oklok for nite kon si sey dem neva sleep.
LUK 12:39 But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house.
LUK 12:40 Una must dey ready too, bikos Man Pikin go kom wen nobody dey espect am.”
LUK 12:41 Den Pita ask am, “Oga God, na only wi yu dey tell dis parabol, abi na evribody?”
LUK 12:42 Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
LUK 12:43 Di savant wey en oga kom back kon meet am dey do en work, make e happy well-well.
LUK 12:44 I tell una true word, di oga go sey make e kare for all en propaty.
LUK 12:45 But if dat savant tink for en mind sey, ‘My oga go tey small and e bigin beat di oda savants, weda na man or woman; e kon dey chop, dey drink anyhow,
LUK 12:46 den di oga kon kom back for di day wen di savant nor tink sey e go kom. Di oga go ponish di savant kon lock am for where dem dey keep wiked pipol.’
LUK 12:47 “Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well.
LUK 12:48 But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”
LUK 12:49 “I bring fire kom dis world and I wish sey di fire don dey katch!
LUK 12:50 E get one baptizim wey dem go baptize mi and my mind nor go fit rest until e happen!
LUK 12:51 Una tink sey na peace I bring kom dis world? No, I kom divide una!
LUK 12:52 From naw go, family wey bi five go divide, three go dey against two, two go dey against three.
LUK 12:53 Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husband mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husband mama.”
LUK 12:54 Jesus tell di pipol, “Anytime una si sey di kloud dey go west, una dey know sey, heavy rain won fall and true-true, e go fall.
LUK 12:55 And wen una si breeze dey blow from east, una go sey, ‘Heat go dey today’ and na so e go bi.
LUK 12:56 Una wey dey pritend! Una fit tok how di weda go bi, but why una nor fit tok wetin dey happen so?”
LUK 12:57 “Why una nor dey tok wetin dey good for pipol to do?
LUK 12:58 If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison.
LUK 12:59 I tell una true word, yu nor go komot for der until yu pay all di money wey yu dey whole!”
LUK 13:1 Some pipol wey dey der wen Jesus dey tok kon tell am how Pilate kill some Galilee pipol kon mix dia blood with dia sakrifice.
LUK 13:2 Jesus ansa dem, “Una tink sey na doz Galilee pipol sin pass evribody, bikos dem sofa all dis tins?
LUK 13:3 I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!
LUK 13:4 Doz eighteen pipol wey die wen towa fall for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pass for Jerusalem?
LUK 13:5 I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!”
LUK 13:6 Jesus tell dem dis parabol, “One man plant fig tree for en farm, so e kon dey look for fruit from di tree, but e nor si.
LUK 13:7 Naim e kon tell doz wey dey wosh di farm sey, ‘Since three years naw, I dey fine fruit for dis tree, but wen I look, I nor dey si. So, make una kut am down! Why wi still let am dey take space?’
LUK 13:8 But di farmer ansa, ‘Oga God, still leave am for dis year make I put fertaliza,
LUK 13:9 Den if e bear fruit next year, wi go leave am, but if e nor bear, yu fit kut am trowey.’ ”
LUK 13:10 Wen Jesus dey tish for one sinagog for Sabat Day,
LUK 13:11 one woman wey evil spirit bend en body for eighteen years dey der.
LUK 13:12 Wen Jesus si am, e koll di woman kon tell am, “Woman, yu don free from yor trobol.”
LUK 13:13 Jesus tosh di woman and at wons, en body kon strait and e start to praiz God.
LUK 13:14 But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”
LUK 13:15 Den Jesus ansa am, “Yu wey dey pritend! Una nor dey luz una melu or donkey from rope go drink wota for Sabat Day?
LUK 13:16 So make I nor free dis woman wey bi Abraham pikin, wey dey Satan prison for eighteen years, bikos today na Sabat Day?”
LUK 13:17 Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.
LUK 13:18 Jesus ask di pipol, “Wetin God Kingdom bi like? How I won take diskribe am?
LUK 13:19 E bi like mustard seed wey pesin plant for en farm. Di seed grow kon turn to big tree and birds build dia house for di tree.”
LUK 13:20 Jesus tok again sey, “Wetin I go tok sey God Kingdom bi like?
LUK 13:21 E bi like yist wey woman mix with three basket of flower so dat di bread go raiz.”
LUK 13:22 Jesus travel pass some town and village kon dey tish as e dey go Jerusalem.
LUK 13:23 Somebody kon ask am, “Oga God, na only few pipol God go save?” Jesus tell dem,
LUK 13:24 “Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit.
LUK 13:25 If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’ “But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’
LUK 13:26 “Den una go sey, ‘Wi chop and drink with yu and yu tish for awa town too.’
LUK 13:27 “But e go sey, ‘I nor know where una from kom! Make una nor near mi, una bi wiked pipol!’
LUK 13:28 “Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside.
LUK 13:29 Pipol go from east, west, nort and sout kon sidan for di party for God Kingdom.
LUK 13:30 Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last.”
LUK 13:31 Dat time, some Farisee pipol kom meet Jesus tok sey, “Run komot for here, bikos Herod won kill yu.”
LUK 13:32 But Jesus tell dem, “Make una go meet dat yeye man tell am, ‘Si, for today, tumoro and next tumoro, I go still dey drive demons dey heal pipol, until my work go finish.’
LUK 13:33 But for today, tumoro and next tumoro, I go-go my way, bikos e nor fit happen sey dem go kill profet outside Jerusalem.
LUK 13:34 “Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri!
LUK 13:35 Make una look, una shidren don skata! And I tell una true word, una nor go si mi again until una go sey, ‘God don bless di pesin wey kom with en name!’ ”
LUK 14:1 For one Sabat Day, wen Jesus go chop for one Farisee oga house, di pipol kon dey look am,
LUK 14:2 bikos one man wey en hand and leg swell-up, stand for en front.
LUK 14:3 Jesus kon ask di pipol wey sabi di law well-well and di Farisee pipol sey, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
LUK 14:4 Dem nor tok anytin. Naim Jesus hold di man, heal am kon sey make e dey go.
LUK 14:5 Den Jesus tell dem, “If any of una get pikin or melu wey fall inside well for Sabat Day, una nor go kwik-kwik draw am kom out?”
LUK 14:6 But dem nor fit ansa.
LUK 14:7 Wen Jesus si how di pipol wey dem invite dey rush to sidan for betta chair, e kon tell dem one parabol:
LUK 14:8 “Wen dem invite yu go party, nor rush go sidan for betta chair, bikos di pesin wey dey do di party fit don invite pesin wey big pass yu.
LUK 14:9 Den di pesin wey invite two of una go tell yu, ‘Get up make dis man sidan.’ Den with shame, yu go-go sidan for back.
LUK 14:10 But wen dem invite yu, make yu sidan for back chair, so dat wen di pesin wey dey do di party si yu, e go sey, ‘My friend, kom sidan for dis betta place for front.’ Den all di pipol wey dey follow yu chop, go give yu respet.
LUK 14:11 Anybody wey dey karry body up, dem go bring am down and anybody wey put en body for groun, dem go karry am up.”
LUK 14:12 Jesus still tell di man wey invite am, “Wen yu dey do party, nor invite yor friends, brodas, rilashons and neighbours wey get money, so dat wen dem dey do dia own party, dem go invite yu too.
LUK 14:13 Instead wen yu dey do big party, make yu invite poor pipol, pipol wey dia leg or hand kut komot, pipol wey nor fit waka and pipol wey nor dey si.
LUK 14:14 Den, God go bless yu, bikos dem nor go fit pay yu back, but na God go pay yu wen E go raiz en pipol from deat; di pipol wey do wetin E like.”
LUK 14:15 Wen one of di pipol for di party hear wetin Jesus tok, e kon tell Jesus, “God don bless evribody wey go chop for di party for en kingdom!”
LUK 14:16 But Jesus tell am, “One man do big party kon invite many pipol kom.
LUK 14:17 Wen di party time rish, e kon tell en savant make dem go tell evribody wey e invite sey, ‘Make una kom, bikos evritin don ready.’
LUK 14:18 “But all of dem kon dey komplain one-by-one. Di first one sey, ‘I just buy land and I won go si am. Abeg, make yu nor vex.’
LUK 14:19 “Anoda one sey, ‘I just buy ten melu and I dey go look how dem bi. Abeg, make yu nor vex.’
LUK 14:20 “Di last one kon sey, ‘I nor go fit kom, bikos I just marry new wife.’
LUK 14:21 “So di savant kom back kon tell en oga evritin wey dem tok. Di oga vex well-well kon tell di savant, ‘Make yu go all di street and korna-korna wey dey dis town, go bring poor pipol: pipol wey dia leg or hand kut komot and pipol wey nor fit waka kon di party.’
LUK 14:22 “Afta, di savant sey, ‘Oga God, I don do wetin yu tok and di party neva still full.’
LUK 14:23 “So di oga tell di savant, ‘Make yu go main road and enter evriwhere for di aria, tell pipol make dem kom, so dat my house go full.’
LUK 14:24 Bikos I tell yu, nobody among doz pipol wey I first invite, go taste my food!”
LUK 14:25 Plenty pipol dey waka follow Jesus for road, so e turn look dem kon sey:
LUK 14:26 “If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.
LUK 14:27 Anybody wey nor gri karry en cross follow mi, nor fit bi my disciple.
LUK 14:28 “Wish of una wey won build big house, nor go first kakulate weda di money wey e get go rish to finish am?
LUK 14:29 If e nor do so, wen e don lay di foundashon and e nor fit finish di house, evribody wey si wetin happen, go kon dey laf am.
LUK 14:30 Dem go sey, ‘Dis man start to build house and e nor fit finish am!’
LUK 14:31 “Abi wish king wey won go fight anoda king, nor go first sidan tink weda di 10,000 men wey e get go fit fight di 20,000 wey di oda king get?
LUK 14:32 If e si sey e nor go fit win, e go send messenja wen di oda king still dey far, go ask am how dem go take setol.
LUK 14:33 Like dis too, nobody fit bi my disciple if e nor komot en mind from evritin wey e get.
LUK 14:34 “Salt good, but if e nor get taste, how dem go fit make am sweet again?
LUK 14:35 Pipol nor go fit use am do anytin, na trowey dem go trowey am. Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok!”
LUK 15:1 Anytime Jesus dey prish, tax kollectors and sinnas dey kom listin to am.
LUK 15:2 But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”
LUK 15:3 So, Jesus kon tell dem dis parabol:
LUK 15:4 “If yu get hundred sheep and one lost, yu nor go leave di ninty-nine wey remain go find dat one till yu si am?
LUK 15:5 Den wen yu si am, yu go karry am for shoulder, dey happy.
LUK 15:6 Wen yu rish house, yu go koll yor friends and neighbours sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my sheep wey lost before.’
LUK 15:7 I tell una true word, na so happiness dey for heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipol wey don already dey with God.
LUK 15:8 “Or, if one woman get ten koins and one lost, wetin e go do? E nor go lite lamp, swip di whole house until e si am?
LUK 15:9 Wen e don si am, e go koll en friends and neighbours gada kon sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my money wey lost before.’
LUK 15:10 I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”
LUK 15:11 Den Jesus sey, “One man dey wey get two sons.
LUK 15:12 Di yonga one kon tell en papa, ‘Give mi my own share for awa propaty.’ So en papa kon gi-am.
LUK 15:13 “Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.
LUK 15:14 Wen e don finish all wetin e get, e nor si anytin to chop, bikos honga dey for dat kountry, so e kon dey sofa.
LUK 15:15 E kon dey work for one man for der, di man dey send am go en farm go give pig food.
LUK 15:16 Di honga kon make am dey won chop di food wey di pig dem dey chop, bikos nobody gi-am food.
LUK 15:17 “But wen en eye klear, e kon sey, ‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish, but hongry don nearly kill mi for here!
LUK 15:18 I go get up go meet my papa tell am, “Papa I don sin against heaven and against yu.
LUK 15:19 I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.” ’
LUK 15:20 So e get up kon go meet en papa. “But wen en papa si am dey kom from far, e sorry for am, run go meet am, hold am near body kon kiss am.
LUK 15:21 “Den di pikin tell am, ‘Papa, I don sin against heaven and yu. I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.’
LUK 15:22 “But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.
LUK 15:23 Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,
LUK 15:24 bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
LUK 15:25 “By dat time, di senior son dey kom from farm where e go work. Wen e don near house, e kon dey hear music and si pipol dey dance.
LUK 15:26 So e koll one savant kon ask am, ‘Wetin dey happen?’
LUK 15:27 Di savant ansa, ‘Yor broda don kom back and yor papa don kill di melu wey fat pass, bikos e kom back well and nor-tin bad happen to am.’
LUK 15:28 “Di senior broda kon dey vex and e nor gri enter house, so en papa kon beg am make e enter.
LUK 15:29 So, e tell en papa, ‘Si, all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu, but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.
LUK 15:30 But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo, yu kon kill di melu wey fat pass for am!’
LUK 15:31 “Den di papa tell am, ‘My pikin, yu always dey here with mi and evritin wey I get na yor own.
LUK 15:32 But e good make I do party, bikos yor broda die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, wi don si am.’ ”
LUK 16:1 Jesus tell en disciples, “E get one rish man wey hear sey en manaja dey waste en money.
LUK 16:2 So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’
LUK 16:3 “Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.
LUK 16:4 I know wetin I go do, so dat wen my oga sak mi, I go get friends wey go welkom mi for dia house.’
LUK 16:5 “So e gada all di pipol wey dey hold en oga money. E kon ask di first one, ‘How mush yu dey whole my oga?’
LUK 16:6 “Di man ansa, ‘One hundred gallon olive oil.’ Di manaja kon sey, ‘Take dis paper, sidan kwik-kwik make yu rite fifty.’
LUK 16:7 “Den e ask anoda one, ‘How mush yu dey whole?’ “Di sekond man sey, ‘1,000 basket for wheat.’ “Di manaja tell am, ‘Take dis paper, make yu rite eight hundred.’
LUK 16:8 “Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
LUK 16:9 So I tell una true word, make una use una money well, so dat una go make friends for unasef and wen di money finish, God go welkom una for en kingdom wey go dey forever.
LUK 16:10 “Anybody wey fit handle small tins, go fit handle big tins too and anybody wey do wayo for small tins, go still do wayo for big ones too.
LUK 16:11 If pipol nor trust yu with money for dis world, God nor go fit give yu en rishis for heaven.
LUK 16:12 And if pipol nor fit trust yu with dia propaty, na who go give yu yor own?
LUK 16:13 “No savant go fit serve two oga, bikos e must hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en body dan di oda one. So, yu nor go fit serve God and money for di same time.”
LUK 16:14 Wen di Farisee pipol (wey like money) hear dis one, dem kon dey take Jesus make yeye.
LUK 16:15 But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.
LUK 16:16 “Moses Law and di tins wey di profets rite, naim pipol dey follow, before John di Baptist kom. But since e kom, dem don dey prish di Good News about God Kingdom and evribody won force ensef enter.
LUK 16:17 E betta make heaven and eart vanish, dan make even di small-small laws dey yuzles.
LUK 16:18 “Any man wey drive en wife, den marry anoda woman, don kommit adultery and di man wey marry woman wey leave en husband, don kommit adultery too.”
LUK 16:19 “E get one rish man wey dey wear dear-dear klot and e dey enjoy life evriday.
LUK 16:20 But for en gate, one poor man wey en name bi Lazarus and sore full en body, liedan for der,
LUK 16:21 e dey wait to chop wetin fall from di rish man tabol. Dogs sef dey kom lick di sore for en body.
LUK 16:22 “Di poor man kon die and angels karry am go where Abraham dey. Di rish man still die too and dem beri am.
LUK 16:23 As di rish man dey for hell-fire dey sofa, e kon look up si Abraham for far with Lazarus for en korna.
LUK 16:24 Naim e shaut, ‘Papa Abraham, make yu sorry for mi, abeg send Lazarus make e put en finger for wota kon tosh my mout, bikos I dey sofa inside dis fire.’
LUK 16:25 “But Abraham ansa, ‘My pikin, remember sey wen yu dey alive, yu dey enjoy good tins, but Lazarus nor enjoy at-all. But naw, e dey enjoy for here and yu dey sofa for der.
LUK 16:26 Nor bi only dat one sef, but dem block di centre, so dat pipol wey won cross from here go meet una, nor go fit and nobody go fit from una side cross kom meet us.’
LUK 16:27 “So di rish man kon sey, ‘Abeg yu papa, make yu send Lazarus go my papa house for di world,
LUK 16:28 (bikos I get five brodas), so dat e go warn dem, make dem nor for kom sofa for dis place.’
LUK 16:29 “But Abraham ansa, ‘Moses and di profets dey with yor brodas for di world, so make dem listin to dia word.’
LUK 16:30 “Di rish man kon sey, ‘No, sir! But if pesin wey don die go meet dem, dem go turn from sin kom meet God.’
LUK 16:31 “Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
LUK 17:1 Jesus tell en disciples, “Tins wey go make pipol kommit sin must happen, but e go bad well-well for di pesin wey go make dem happen!
LUK 17:2 E betta make dem tie big stone for di pesin neck, trow am for river, dan sey e make any of dis small-small wons kommit sin.
LUK 17:3 Make yu shine yor eye! “If yor broda sin, make yu tell am. If e turn from sin kom meet God, den, make yu forgi-am.
LUK 17:4 Even if e sin against yu seven times for one day and e kon tell yu seven times sey, ‘I don shange’, yu must forgi-am.”
LUK 17:5 Di disciples kon tell Jesus, “Wi beg! Make yu make awa faith strong.”
LUK 17:6 Jesus ansa, “Even if una faith small like mustard seed, una go fit tell dis big tree sey, ‘Make yu komot from here go enter river’ and e go obey una.
LUK 17:7 “Wish of una go tell en savant wen e kom from farm afta e don feed di sheep and melu finish sey, ‘Kom sidan, make yu follow mi chop’?
LUK 17:8 No! Instead una go tell am, ‘Prepare my evening food and serve mi, make I chop and drink. Wen I don finish, yu fit go chop yor own.’
LUK 17:9 Di oga nor go tank di savant sey e do wetin e send am, abi e go do so?
LUK 17:10 Na so too e go bi with una. Wen una don do all wetin dem send una, make una sey, ‘Na savant wi bi, wi nor rish make dem praiz us, bikos wi just do wetin wi suppose to do.’ ”
LUK 17:11 As Jesus dey go Jerusalem, e kon pass di place wey divide Samaria and Galilee.
LUK 17:12 As e dey enter one village, ten men wey get leprosy meet am for road. Dem stand for far,
LUK 17:13 kon dey shaut, “Oga God Jesus! Wi beg, make yu sorry for us.”
LUK 17:14 Wen Jesus si dem e kon sey, “Make una go show unasef to di priests.” And as dem dey go for road, dia body kon well.
LUK 17:15 Wen one of dem si sey e don well, e kon turn back dey shaut dey praiz God.
LUK 17:16 E fall face groun for Jesus front kon dey tank am. (Di man na from Samaria.)
LUK 17:17 Den Jesus ask, “Nor bi ten pipol I heal? Where di oda Nine?
LUK 17:18 Na only dis man wey bi strenja fit kom back kon praiz God?”
LUK 17:19 Den Jesus tell di man, “Get up make yu dey go. Yor faith don make yu well.”
LUK 17:20 One day, di Farisee pipol kon ask Jesus wen God Kingdom go kom. Jesus ansa, “God Kingdom nor go kom with sign wen pipol go si
LUK 17:21 and nobody go fit sey, ‘Si am for here!’ Or ‘Si am for der!’ Bikos true-true, God Kingdom don already dey with una.”
LUK 17:22 Den Jesus tell en disciples, “Di time dey kom wen una go won si Man Pikin, but una nor go si am.
LUK 17:23 Dat time, pipol go tell una, ‘Si am for der!’ or ‘Si am for here!’ Make una nor follow dem.
LUK 17:24 Bikos as tonda lite dey flash from one side go anoda for sky, na so Man Pikin go kom for en time.
LUK 17:25 But e must first sofa many tins and di pipol for dis generashon go rijet am.
LUK 17:26 “As e bi for Noah time, na so e go still bi for Man Pikin time.
LUK 17:27 Dat time, pipol dey chop and drink, even for di day wen Noah enter di ark, men and wimen still dey marry, until wota kon distroy all of dem.
LUK 17:28 “Na so e still bi for Lot time, pipol dey chop and drink, dey buy and sell, dey plant and build house;
LUK 17:29 but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem.
LUK 17:30 “Na so e go bi for di day wen Man Pikin go show ensef.
LUK 17:31 Dat day, anybody wey dey on-top rut for en house, make e nor go inside house go karry anytin and anybody wey dey farm, make e nor go back to en house.
LUK 17:32 Make una remember wetin happen to Lot wife!
LUK 17:33 Anybody wey won keep en life, go luz am and anybody wey luz en life, go save am.
LUK 17:34 I tell una true word, dat nite, two pipol go dey one bed, God go take one kon leave di oda one.
LUK 17:35 Two wimen go dey grind pepper togeda; God go take one kon leave di oda one.
LUK 17:36 Two pipol go dey farm dey work; God go take one kon leave di oda one.”
LUK 17:37 Den di disciples ask Jesus, “Oga God, for where dis tins go for happen?” Jesus ansa, “Yu si, na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”
LUK 18:1 Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.
LUK 18:2 E sey, “One judge dey for one town wey nor dey fear God and e nor dey respet anybody.
LUK 18:3 For dat town, e get one woman wey en husband don die. E kon go meet di judge kon beg am, ‘Make yu help mi, bikos some pipol dey shit mi.’
LUK 18:4 “Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody,
LUK 18:5 but bikos dis woman dey disturb mi, I go make sure sey e get wetin e suppose get, oda-wise e nor go let mi rest with dis en beggy-beggy wey nor dey finish.’ ”
LUK 18:6 Jesus sey, “If di wiked judge tok like dis,
LUK 18:7 una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?
LUK 18:8 I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
LUK 18:9 Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem.
LUK 18:10 “Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector.
LUK 18:11 Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.
LUK 18:12 I dey fast two times a week and I dey pay one out of evry ten tins wey I get, give yu.’
LUK 18:13 “But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’
LUK 18:14 “I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”
LUK 18:15 Some pipol kon bring dia pikin make Jesus tosh dem. But wen di disciples si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shidren.
LUK 18:16 But Jesus koll di shidren kon sey, “Make una allow di small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem get God Kingdom.
LUK 18:17 I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small pikin, nor go enter inside.”
LUK 18:18 One day, one Jew oga ask Jesus, “Good tisha, wetin I go do to get life wey nor dey end?”
LUK 18:19 Jesus kon tell am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good escept God.
LUK 18:20 Yu know di kommandment dem wey sey, ‘Make yu nor sleep with pesin wey nor bi yor husband or wife, nor kill pesin, nor tif, respet yor papa and mama.’ ”
LUK 18:21 Di man ansa Jesus, “I dey obey all dis law with all my heart since I bi small boy.”
LUK 18:22 Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”
LUK 18:23 Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well.
LUK 18:24 Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom!
LUK 18:25 E dey eazy for kamel to pass nidol whole dan for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom.”
LUK 18:26 Pipol wey hear dis word kon sey, “Den who God go save?”
LUK 18:27 Jesus ansa, “Wetin nor possibol for human being, dey possibol with God.”
LUK 18:28 Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!”
LUK 18:29 Jesus kon tell dem, “I tell una di trut, anybody wey leave en house, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kingdom,
LUK 18:30 God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both for dis world and for di life wey dey kom.”
LUK 18:31 Jesus koll di twelf disciples go korna kon tell dem, “Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite about Man Pikin go happen for der.
LUK 18:32 Bikos dem go gi-am to Gentile pipol and dem go laf, curse and spit for en body.
LUK 18:33 Dem go flog am well-well and dem go kon kill-am. But for di third day, e go wake-up.”
LUK 18:34 But di twelf disciples nor undastand wetin Jesus tok, bikos God hide wetin e mean from dem.
LUK 18:35 As Jesus near Jeriko, one man wey blind sidan for di road korna dey beg.
LUK 18:36 Wen e hear plenty pipol dey pass, e kon ask wetin dey happen.
LUK 18:37 Dem kon tell am sey Jesus wey kom from Nazaret dey pass.
LUK 18:38 So di man kon dey shaut, “Jesus, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
LUK 18:39 So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more, “David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
LUK 18:40 So Jesus stop kon sey make dem bring di beggar kom meet am. Wen di man kom, Jesus ask am,
LUK 18:41 “Wetin yu wont make I do for yu?” Di man sey, “Oga God, I won si again.”
LUK 18:42 Jesus kon tell am, “Make yu si naw, yor faith don heal yu.”
LUK 18:43 At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.
LUK 19:1 Jesus enter Jeriko kon waka go inside di town.
LUK 19:2 For der, e get one man wey en name bi Zakius. E get money well-well, bikos e bi tax kollectors oga. E don tey wey e
LUK 19:3 dey won si Jesus, but e nor fit si am, bikos e bi short man and pipol too plenty.
LUK 19:4 So e run go klimb one sikamore tree make e for fit si am, bikos Jesus go pass dat road.
LUK 19:5 Wen Jesus rish dat place, e look up kon sey, “Zakius, kom down kwik-kwik, bikos I must stay for yor house today.”
LUK 19:6 So Zakius kom down kon welkom Jesus with happiness.
LUK 19:7 Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”
LUK 19:8 But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”
LUK 19:9 Den Jesus sey, “Salvashon don kom dis house today, bikos dis man na Abraham pikin too.
LUK 19:10 Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”
LUK 19:11 As Jesus dey waka near Jerusalem, e kon tell di pipol one parabol to show sey God Kingdom nor go just kom like dat.
LUK 19:12 Jesus kon sey, “One big man travel go one far kountry where dem for won make am king and afta, e kom back.
LUK 19:13 Before e go, e koll ten of en savant kon give each one money sey, ‘Make una take dis money trade and make profit till I kom back.’
LUK 19:14 “But e own pipol nor like am, so dem kon send message follow am sey, ‘Wi nor wont dis man to bi awa king!’
LUK 19:15 “Wen e kom back afta e don get di kingdom, e kon koll en savants wey e give money make e for know how mush dem don gain.
LUK 19:16 “So di first one stand for en front sey, ‘Oga God, I don gain ten koins join di ones wey yu give mi.’
LUK 19:17 “Di oga kon tell am, ‘Yu do well, yu bi good savant! Bikos yu dey faithful with small tin, I go make yu oga ova ten towns.’
LUK 19:18 “Den di sekond one sey, ‘Oga God, I don gain five koins join di ones wey yu give mi.’
LUK 19:19 “So di oga tell am, ‘Yu go bi oga for five towns.’
LUK 19:20 “Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot.
LUK 19:21 Bikos I dey fear and know sey yu hash well-well. Yu dey chop food wey nor bi yor own and yu dey plok fruit wey yu nor plant!’
LUK 19:22 “Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?
LUK 19:23 Den why yu nor put my money for bank, so dat wen I kom, I go kollect am with intrest wey go dey on-top?’
LUK 19:24 “Den di oga tell di oda savants, ‘Make una take di money from am, gi-am to di savant wey get ten.’
LUK 19:25 “Dem ansa, ‘Oga God, di man don already get ten!’
LUK 19:26 “Di oga kon sey, ‘I tell una, anybody wey get, God go gi-am more, but di pesin wey nor get, even di small one wey e get, God go take am from am.
LUK 19:27 But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”
LUK 19:28 Afta Jesus tok dis word, e kon go Jerusalem.
LUK 19:29 Wen e rish Betpage and Betany, for di place wey dem dey koll Mount Olives, e kon send two of en disciples sey,
LUK 19:30 “Make una go di village wey dey front. Wen una enter, una go si one small donkey wey nobody don sidan put before, wey dem tie for der. Make una luz am kom give mi.
LUK 19:31 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una ansa, ‘Di oga nid am.’ ”
LUK 19:32 So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jesus tell dem.
LUK 19:33 As dem dey luz di donkey, di owner kon ask dem, “Why una dey luz am?”
LUK 19:34 Dem ansa, “Di oga nid am.”
LUK 19:35 Dem take di donkey kon put dia klot on-top am, den Jesus sidan put.
LUK 19:36 As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
LUK 19:37 As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.
LUK 19:38 “God don bless di king wey dey kom with en name! Make peace dey for heaven and make all di glory bi God own!”
LUK 19:39 But some Farisee pipol wey dey among di pipol kon tell Jesus, “Tisha, make yu tell yor disciples make dem kwayet.”
LUK 19:40 Jesus ansa, “I tell una true word, if dem kwayet, even stones go start to dey shaut!”
LUK 19:41 Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,
LUK 19:42 den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una.
LUK 19:43 Time go kom wen una enemies go surround una for evry korna kon block una road.
LUK 19:44 Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”
LUK 19:45 Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell tins for der,
LUK 19:46 e kon sey, “God word sey, ‘My house na prayer house’, but una don turn am to house where tif dey hide put!”
LUK 19:47 Jesus kon dey tish evriday for di temple. Di priest oga dem, di law tishas with di big leaders among di pipol kon dey find how dem go take kill Jesus.
LUK 19:48 But dem nor get any shance, bikos pipol dey listin to wetin Jesus dey tish.
LUK 20:1 One day wen Jesus dey tish pipol for di temple, di priest oga dem and di law tishas kon meet am,
LUK 20:2 dey sey, “Make yu tell us, na wish pawa yu take dey do dis tins? Na who give yu di pawa sef?”
LUK 20:3 Jesus ansa dem, “Make I still ask una one kweshon and make una ansa mi.
LUK 20:4 John baptizim kom from heaven, abi na from pipol?”
LUK 20:5 Dem kon dey tok with each oda sey, “If wi sey na from heaven, e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
LUK 20:6 But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”
LUK 20:7 So dem kon tell Jesus sey dem nor know where di baptizim from kom.
LUK 20:8 Den Jesus tell dem, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”
LUK 20:9 Jesus kon tell di pipol one parabol: “One man rent en grape farm give tenants, den e travel.
LUK 20:10 Wen harvest time rish, e kon send one savant go meet di tenants make dem gi-am en share from di harvest. But di tenants beat di savant kon send am go back with empty hand.
LUK 20:11 So e send anoda savant and dem still beat and do am anyhow, den dem kon send am back with empty hand.
LUK 20:12 Di man kon send di third savant go, but di tenants wound am kon trow am outside too.
LUK 20:13 “So di grape farm owner kon sey, ‘Wetin I go do naw? I go send di only pikin wey I get, may bi dem go respet am.’
LUK 20:14 “But wen di tenant si di pikin, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so, make wi kill-am, so dat all di propaty go bi awa own!’
LUK 20:15 Dem karry di pikin go outside, kon kill-am. So, wetin una tink sey di owner go do di tenants?
LUK 20:16 E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”
LUK 20:17 But Jesus look dem for face kon ask, “Wetin God word mean wen e sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet, don turn to di main stone?’
LUK 20:18 Anybody wey fall for dis stone, go break into pieces and di pesin wey di stone fall press, go die.”
LUK 20:19 Den di Farisee pipol and di law tishas won kon arrest Jesus for dat place, bikos dem know sey Jesus dey tok against dem. But dem dey fear di pipol.
LUK 20:20 Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.
LUK 20:21 So dem ask am, “Tisha, wi know sey wetin yu dey tok korrect and yu nor dey do wayo, bikos yu dey tish di trut about God.
LUK 20:22 Make yu tell us, ‘E good make wi pay tax give Caesar?’ ”
LUK 20:23 But Jesus know sey na trap, so e kon tell dem,
LUK 20:24 “Make una show mi di money. Wish pesin face and name dey?” Dem ansa, “Na Caesar own.”
LUK 20:25 So Jesus tell dem, “Den make una give Caesar wetin bi Caesar own and make una give God wetin bi God own.”
LUK 20:26 So dem nor fit get am with en word for di pipol present. Dem sopraiz for di ansa wey e give and dem nor fit tok again.
LUK 20:27 Den some Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus,
LUK 20:28 dey sey, “Tisha, Moses Law sey, ‘If pesin die leave en wife and di woman nor born for am, en broda must marry di woman wey en husband don die, so dat e go born shidren for di broda wey don die.’
LUK 20:29 E get one family wey get seven brodas. Di first one marry, but dem nor born before di man die.
LUK 20:30 Den di sekond one kon marry di woman,
LUK 20:31 den di third one, until nomba seven die too, but di woman nor still born for any of dem.
LUK 20:32 At last, di woman kon die too.
LUK 20:33 For di day wey pipol go wake-up from deat, wish pesin wife di woman go bi, since all di seven brodas marry am?”
LUK 20:34 So Jesus ansa dem, “Pipol for di word naw dey marry.
LUK 20:35 But di pipol wey God go wake-up from deat karry go heaven, nor go marry.
LUK 20:36 Dem go bi like angels and dem nor go die again. Dem go bi God shidren, bikos dem don wake-up from deat.
LUK 20:37 But even Moses tok sey pipol wey don die go wake-up. Moses tok like dis wen e rite about how e koll God, ‘Abraham, Isaak and Jakob God’, wen e dey di bush wey dey burn.
LUK 20:38 Awa God nor bi God for dead pipol, but na God wey dey alive, bikos for God eye, evribody dey alive.”
LUK 20:39 Den some law tishas ansa, “Tisha, yu don tok well!”
LUK 20:40 So dem nor dare ask Jesus kweshon again.
LUK 20:41 Jesus kon tell dem, “Wetin make dem sey Mezaya na David pikin?
LUK 20:42 Bikos David ensef tok for Psalms Book sey, “ ‘God tell my oga sey, “Sidan for my rite hand,
LUK 20:43 until I go put yor enemies under yor leg.” ’
LUK 20:44 If David koll am ‘Oga God,’ how e kon take bi David pikin?”
LUK 20:45 As all di pipol dey listin, Jesus kon tell en disciples,
LUK 20:46 “Make una guide unasef from di law tishas. Dem like to dey waka with long klot make pipol dey shaut dia name for market and chairs wey betta pass for sinagog, na der dem dey like to sidan.
LUK 20:47 Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”
LUK 21:1 For inside di temple, Jesus kon si rish pipol dey put dia money for ofrin box.
LUK 21:2 E still si one poor woman wey en husband don die dey put two koins inside di box.
LUK 21:3 Jesus kon sey, “I tell una true word, di money wey dis poor widow put so, big pass all di oda pipol own;
LUK 21:4 bikos di rish pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but as dis woman poor rish, e put evritin wey e get.”
LUK 21:5 As some pipol dey tok about how di temple fine rish, bikos of di stones wey dem take build am and di ofrin wey pipol dey give, Jesus kon sey,
LUK 21:6 “Di day dey kom wen all di stones wey una dey si so, go skata and one nor go dey on-top anoda again.”
LUK 21:7 So, dem kon ask am, “Tisha, wen dis tins go happen? And wetin go bi di sign sey di time for dis tins to happen don rish?”
LUK 21:8 Jesus ansa, “Make una shine una eye, so dat nobody go deceive una. Bikos many pipol go kom prish with my name sey, ‘Na mi bi Jesus’ or ‘Di time don near.’ Make una nor follow dem!
LUK 21:9 And wen una hear rumor about war and wahala, make una nor fear. Bikos all dis tins go first happen, but dat nor mean sey di end don rish.”
LUK 21:10 Den Jesus tell dem, “Kountry go fight kountry, kingdom go fight kingdom.
LUK 21:11 Strong eartkweke, honga and sickness go dey evriwhere; difren-difren tins and bad signs go dey happen and fear go katch evribody.
LUK 21:12 “But before dem go happen, dem go arrest and ponish una for wetin una nor do, den go karry una go judge for inside sinagog, den dem go trow una inside prison. Dem go karry una go meet kings and govnors, bikos of my name.
LUK 21:13 Dis na di time for una to spread di Good News.
LUK 21:14 So make una ready una mind before di time rish. Make una nor tink how una go take defend unasef,
LUK 21:15 bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.
LUK 21:16 Una papa, mama, brodas, rilashons and friends go sey dem nor know una and dem go even kill some of una.
LUK 21:17 Evribody go hate una bikos of my name.
LUK 21:18 But God eye go always dey wosh una.
LUK 21:19 So, if una stand rish di end, God go save una.”
LUK 21:20 “But wen una si sey sojas don surround Jerusalem, make una know sey di time wey dem go distroy Jerusalem, don near.
LUK 21:21 So, make di pipol wey dey Judea run go mountin and doz wey dey inside town must komot der. Make doz wey dey outside, nor enter di town again,
LUK 21:22 bikos na dat time God go judge di world, since evritin wey dem rite for God word, must happen.
LUK 21:23 Dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle or get small pikin for hand! Strong wahala go kom for dis land and God ponishment go fall for pipol head.
LUK 21:24 Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.
LUK 21:25 “Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land.
LUK 21:26 Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey.
LUK 21:27 Den, dem go si Man Pikin dey kom inside kloud with pawa and glory.
LUK 21:28 So, wen dis tins dey happen, make una stand and dey ready, bikos una salvashon don near.”
LUK 21:29 Den, Jesus kon tell dem dis parabol: “Make una tink about di fig tree and all di oda trees.
LUK 21:30 Wen dia leaf start to fall komot, make una know sey dry sizin don near.
LUK 21:31 Na so una go still know too, wen una si all dis tins dey happen, una go know sey God Kingdom don near.
LUK 21:32 “I tell una true word, di pipol for dis world naw nor go die finish before all dis tins go happen.
LUK 21:33 Heaven and eart go vanish komot, but my word go dey forever.
LUK 21:34 “So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect,
LUK 21:35 bikos dat Day go sopraiz evribody wey dey for dis world.
LUK 21:36 But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”
LUK 21:37 So, Jesus kon dey tish for di temple evriday, but wen nite rish, e go-go Mount Olives.
LUK 21:38 And for early morning, all di pipol dey go listin to am inside di temple.
LUK 22:1 Time kon rish for Bread (wey nor get yist) Feast, wey dem dey koll Passova.
LUK 22:2 Di priest oga dem and di law tishas dey fine how dem go take kill Jesus, but dem dey fear di pipol.
LUK 22:3 So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples.
LUK 22:4 E kon go tell di offisa wey dey guide di temple sey e go sell Jesus give dem.
LUK 22:5 Dem happy well-well kon promise am sey dem go gi-am money.
LUK 22:6 Judas gri and e kon bigin find sekret way to sell Jesus give dem, so dat pipol nor go know.
LUK 22:7 Di day for di Bread (wey nor get yist) Feast, wen dem dey kill sheep for sakrifice, kon rish.
LUK 22:8 Jesus tell Pita and John, “Make una go prepare di Passova food wey wi go chop.”
LUK 22:9 Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”
LUK 22:10 Jesus ansa dem, “Listin, wen una enter di town, una go meet one man wey karry wota pot, make una follow am enter di house wey e go enter,
LUK 22:11 make una tell di pesin wey get di house sey, Di Tisha sey make wi ask yu, ‘Where di room wey mi and my disciples go for chop di Passova food?’
LUK 22:12 E go show una one big room where tabol and chair dey for upstair. Make una prepare evritin for der.”
LUK 22:13 Wen dem go, dem kon si evritin as Jesus tell dem sey e go bi, so dem prepare di Passova food for der.
LUK 22:14 Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am.
LUK 22:15 Jesus tell dem, “I really won chop dis Passova food with una before I go sofa.
LUK 22:16 Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”
LUK 22:17 Den Jesus take one cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, “Make una take dis cup and divide am among unasef.
LUK 22:18 Bikos I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine again, until God Kingdom go kom.”
LUK 22:19 Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”
LUK 22:20 Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”
LUK 22:21 “I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol.
LUK 22:22 Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!”
LUK 22:23 So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.
LUK 22:24 Dem kon dey kworel among diasef sey wish of dem big pass.
LUK 22:25 So Jesus tell dem, “Gentile kings dey give dia pipol orda, yet di pipol still dey koll dem, ‘Pipol Friends.’
LUK 22:26 But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant.
LUK 22:27 Na who big pass? Na di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serve am? Nor bi di one wey sidan for tabol? But I dey do like savant among una.
LUK 22:28 Na una stay with mi wen I dey pass thru wahala.
LUK 22:29 So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi.
LUK 22:30 For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.
LUK 22:31 “Simon! Simon! Make yu listin! God don allow Satan make e test all of una, so dat God go fit separate bad pipol from di good ones.
LUK 22:32 But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
LUK 22:33 Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”
LUK 22:34 But Jesus sey, “Pita, make I tell yu di trut, fawol nor go do ‘Kukuruku’ dis nite until yu don tok three times sey yu nor know mi.”
LUK 22:35 Den Jesus tell dem, “Wen I send una go out, without money, bag or sandals, e get anytin wey una nid wey una nor get?” Dem ansa, “No!”
LUK 22:36 E kon tell dem, “But naw, pesin wey get money or traveling bag must karry am. And pesin wey nor get swod must sell en klot kon use di money by one.
LUK 22:37 Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”
LUK 22:38 Di disciples kon sey, “Oga God, si two swod for here.” Jesus ansa, “E don do.”
LUK 22:39 Den Jesus komot, kon waka as e dey always do, go Mount Olives and en disciples follow am.
LUK 22:40 Wen dem rish der, Jesus kon tell dem, “Make una pray so dat una nor go fall enter temptashon.”
LUK 22:41 Den e leave dem, waka go far small, kon knee down dey pray,
LUK 22:42 “Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.”
LUK 22:43 One angel appear from heaven kon give Jesus pawa.
LUK 22:44 Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
LUK 22:45 Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well.
LUK 22:46 So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”
LUK 22:47 As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face.
LUK 22:48 So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?”
LUK 22:49 Wen doz wey dey near Jesus si wetin won happen, dem ask am, “Oga God, make wi use awa swod?”
LUK 22:50 Den one among dem attack di priest savant kon kut en rite ear komot.
LUK 22:51 But Jesus shaut for am make e stop, den tosh di man ear kon heal am.
LUK 22:52 Den Jesus ask di priest oga dem, di ofisas wey dey guide di temple and di eldas wey kom meet am sey, “Una karry swod and wood like sey una dey kom arrest tif?
LUK 22:53 Since wen I dey with una for di temple una nor arrest mi. But na una time bi dis, di time wey darkness pawa go rule.”
LUK 22:54 Den dem arrest Jesus, karry am go di High Priest house. But Pita dey follow dem for back-back.
LUK 22:55 Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too.
LUK 22:56 One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”
LUK 22:57 But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”
LUK 22:58 Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?” But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”
LUK 22:59 Wen one hour don pass, anoda pesin kon sey, “I sey dis man dey with dem, bikos en too kom from Galilee.”
LUK 22:60 But Pita sey, “Oga God! I nor know wetin yu dey tok.” At wons, as e still dey tok, naim one fawol do, “Kukuruku!”
LUK 22:61 Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.”
LUK 22:62 Den Pita go outside, bigin kry.
LUK 22:63 Di guards bigin laf Jesus kon dey beat am anyhow.
LUK 22:64 Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?”
LUK 22:65 Dem still curse am with difren words.
LUK 22:66 Wen morning rish, di eldas with di priest oga dem and di law tishas kon gada. Den dem take Jesus go dia kansol
LUK 22:67 kon tell am sey, “If yu know sey na yu bi Christ, make yu tell us.” But Jesus ansa, “If I tell una, una nor go bilive mi
LUK 22:68 and if I ask una kweshon, una nor go gri ansa.
LUK 22:69 But from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand where pawa dey.”
LUK 22:70 All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?” Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”
LUK 22:71 Den dem kon sey, “Why wi nid anoda witness? E don tok evritin by ensef!”
LUK 23:1 Den di Farisee pipol and di oda pipol take Jesus go meet Pilate,
LUK 23:2 dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”
LUK 23:3 Pilate kon ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok.”
LUK 23:4 Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”
LUK 23:5 But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”
LUK 23:6 Wen Pilate hear dis one, e kon ask weda Jesus na Galilee pesin.
LUK 23:7 Wen e hear sey Jesus kom from Jerusalem, where Herod dey rule for dat time, e kon sey make dem take Jesus go meet am.
LUK 23:8 Wen Herod si Jesus, e happy well-well, bikos e don tey wen e won si am since e hear about am. E dey hope sey Jesus go do mirakle for en present.
LUK 23:9 Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all.
LUK 23:10 Di priest oga dem and di law tishas dey akuiz Jesus with vexnashon.
LUK 23:11 Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.
LUK 23:12 Dat day, Herod and Pilate kon bi friends, bikos before dis time dem bi strong enemy.
LUK 23:13 Den Pilate koll di priest oga dem, di eldas and di pipol for dat place
LUK 23:14 kon tell dem, “Una bring dis man kom meet mi sey e dey deceive pipol. Wen I ask am kweshon for una present, I nor si any bad tin wey una sey e do.
LUK 23:15 Even Herod nor still si anytin too, so e sey make dem bring am kom meet us. Dis man nor do anytin wey go make am die.
LUK 23:16 So I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
LUK 23:17 (Na dia tradishon sey Pilate must release one prisona anytime wen dem dey do Passova Feast.)
LUK 23:18 But all of dem kon dey shaut, “Take dis man komot! Na Barabas wi wont!”
LUK 23:19 (Barabas na pesin wey dem put for prison bikos e kause wahala and kill pesin for di town.)
LUK 23:20 Pilate kon tok to dem again, bikos e won free Jesus.
LUK 23:21 But dem still dey shaut, “Kill-am trowey, Kill-am trowey!”
LUK 23:22 Again Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do? I nor si any bad tin wey e do wey go make am die, so I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
LUK 23:23 But dem shaut more-more dey sey, “Kill-am trowey.” Dem shaut sotey Pilate kon do wetin dem wont.
LUK 23:24 So Pilate orda en sojas sey make dem give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
LUK 23:25 E kon free Barabas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prison, bikos e kause wahala and kill pesin for di town.
LUK 23:26 As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus.
LUK 23:27 Many pipol follow Jesus and di wimen among dem kon dey kry.
LUK 23:28 But Jesus turn look dem sey, “Jerusalem wimen, make una nor kry bikos of mi, but make una kry for unasef and for una shidren.
LUK 23:29 Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’
LUK 23:30 Den, “dem go tell di mountins, ‘Make yu fall on-top us!’ And tell di hills, ‘Make yu kover us!’
LUK 23:31 But if dem do dis kind tin for wood wen e still fresh, wetin go happen wen di wood don dry?”
LUK 23:32 Dem still take two oda men wey bi tif, wey dem wont kill, follow Jesus.
LUK 23:33 Wen dem rish di place wey dem dey koll, “Di Skull,” dem kon nail Jesus for cross with di two tif, one for en left and di oda for en rite side.
LUK 23:34 (Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
LUK 23:35 Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”
LUK 23:36 Di sojas still dey laf Jesus and dem kon gi-am wine wey don sawa make e drink,
LUK 23:37 den sey, “If yu bi di Jew pipol king, make yu save yorsef!”
LUK 23:38 Dem kon rite on-top en cross sey, “Dis na, ‘Jew Pipol King.’ ”
LUK 23:39 One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”
LUK 23:40 But di oda tif kon shaut for di first tif, “Yu nor dey fear God as e bi sey na di same ponishment wi dey sofa?
LUK 23:41 Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”
LUK 23:42 Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”
LUK 23:43 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today yu go dey with mi for paradise.”
LUK 23:44 By naw, twelf oklok don nearly rish for aftanoon and darkness kover di whole kountry until three oklok for dat aftanoon,
LUK 23:45 bikos sun stop to shine. Di Temple curtain kon tear into two.
LUK 23:46 So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
LUK 23:47 Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!”
LUK 23:48 So wen all di pipol wey gada dey look si wetin happen, dem kon dey kry go dia house.
LUK 23:49 And evribody wey know Jesus before, stand for far and di wimen wey follow Jesus kom from Galilee, si di tins wey happen.
LUK 23:50 E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.
LUK 23:51 (E nor gri with di oda kansol membas with dia plan and for wetin dem do so.)
LUK 23:52 E go meet Pilate kon ask for Jesus dead body.
LUK 23:53 Den e karry di body from di cross, wrap am with linen klot kon put am for di grave wey e dig inside rock, where dem neva beri anybody put before.
LUK 23:54 Dat day na Friday wen dem dey ready for Sabat Day serimony.
LUK 23:55 Di wimen wey follow Jesus from Galilee kon follow Josef go si di grave. So dem put Jesus body inside.
LUK 23:56 Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.
LUK 24:1 For early morning for di first day for di week, di wimen karry di perfume wey dem prepare go di grave where dem beri Jesus put.
LUK 24:2 Dem kon si sey dem don roll di stone komot from di grave mout,
LUK 24:3 but wen dem enter inside, dem nor si Jesus body for der.
LUK 24:4 As dem dey konfuse bikos of dis tin, dem kon si two men wey dia klot dey shine like lite and dem stand for korna.
LUK 24:5 Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey?
LUK 24:6 E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey,
LUK 24:7 ‘Dem must sell Man Pikin give wiked pipol and dem go kill-am trowey and for di third day, e go wake-up.’ ”
LUK 24:8 Den di wimen kon remember wetin Jesus tell dem,
LUK 24:9 so dem komot from di grave kon go tell di eleven apostles and di rest pipol wetin happen.
LUK 24:10 Na Mary Magdalin, Joanna, Mary wey bi James mama and di oda wimen wey dey with dem, na dem tell di apostles all dis tins.
LUK 24:11 But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen.
LUK 24:12 But Pita kon get up, run go di grave. E ben-down look inside and e si only di klot, den e kon go house dey wonder wetin happen.
LUK 24:13 Dat day, two men among Jesus disciples dey waka go one village wey dem dey koll Emmaus, wey nor too far from Jerusalem.
LUK 24:14 Dem dey tok to each oda about di tins wey happen.
LUK 24:15 As dem dey tok, Jesus kon bigin waka with dem,
LUK 24:16 (but Jesus nor let dem know who e bi.)
LUK 24:17 Den Jesus kon ask dem, “Na wetin make una dey tok like dis for road?” Dem kon stand for one place, dey sopraiz for am.
LUK 24:18 Den one among dem, wey en name bi Kleopas, kon tell am, “Na only yu bi strenja for Jerusalem wey nor know di tins wey dey happen since?”
LUK 24:19 Jesus ask dem, “Wish tins?” Dem ansa, “Di tins about Jesus wey kom from Nazaret, one man wey wetin e dey tok and do show sey en na God profet
LUK 24:20 and how awa priest oga dem and di pipol wey dey rule us kill-am trowey.
LUK 24:21 But wi bin hope sey naim go free Israel and dis tins don happen for three days naw.
LUK 24:22 Some wimen wey dey with us kon even sopraiz us. Dem go where dem beri am put dis morning
LUK 24:23 and dem nor si en body for der. Dem kom back dey tok sey dem si angels wey tell dem sey Jesus dey alive.
LUK 24:24 Den some pipol wey dey with us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, but dem nor si Jesus.”
LUK 24:25 So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok.
LUK 24:26 Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?”
LUK 24:27 Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word.
LUK 24:28 As dem near di village wey dem dey go, Jesus do like sey e won waka go front,
LUK 24:29 but dem tell am, “Make yu stay with us, bikos evening don nearly rish and day go soon dark.” So Jesus enter di village kon follow dem stay.
LUK 24:30 E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.
LUK 24:31 At wons dia eye open and dem kon know am. Den e vanish from dia front.
LUK 24:32 Dem kon tell each oda, “No wonder e bi like sey fire dey burn inside awa heart wen e dey tok with us for road about God!”
LUK 24:33 So dem get up at wons go back to Jerusalem. Dem si di eleven apostles and di oda pipol wey dey with dem
LUK 24:34 kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!”
LUK 24:35 Den dem tok wetin happen for road and how dem take know Jesus wen e divide di bread.
LUK 24:36 As dem still dey tok, Jesus kon stand with dem, tell dem, “Make peace dey with una.”
LUK 24:37 But dem shok kon bigin fear, bikos dem tink sey na spirit dem dey si.
LUK 24:38 Den Jesus kon sey, “Why una dey fear and nor bilive?
LUK 24:39 Make una look my hand and leg and make una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get.”
LUK 24:40 Wen Jesus don tok dis one, e kon show dem en hand and leg.
LUK 24:41 And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?”
LUK 24:42 So dem kon gi-am fish wey dem don kook,
LUK 24:43 e kon take am chop for dia front.
LUK 24:44 Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”
LUK 24:45 Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word
LUK 24:46 kon tell dem, “Na wetin dem rite bi dis, ‘Di Mezaya go sofa and e go wake-up from deat for di third day
LUK 24:47 and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’
LUK 24:48 Una bi witness for dis tins.
LUK 24:49 I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”
LUK 24:50 Den Jesus take dem go Betany kon lift en hand and bless dem.
LUK 24:51 As e dey bless dem, God kon karry am go heaven.
LUK 24:52 So, dem woship am kon go back to Jerusalem dey happy well-well
LUK 24:53 and dem dey go di temple evritime, dey praiz God.
JOH 1:1 Since wen di time start naim di Word dey and di Word dey with God and na God ensef bi di Word.
JOH 1:2 Di Word dey with God from wen time bigin.
JOH 1:3 Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all.
JOH 1:4 Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get.
JOH 1:5 Di lite dey shine inside darkness, but darkness nor gri with am.
JOH 1:6 E get one man wey en name bi John, wey God send kom dis world.
JOH 1:7 E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.
JOH 1:8 Nor bi John ensef bi di lite, but e kom tell pipol about Jesus wey bi di lite.
JOH 1:9 Na Jesus bi di true lite wey go shine for evribody for dis world.
JOH 1:10 E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.
JOH 1:11 E kom meet en own pipol, but dem nor wont am.
JOH 1:12 But evribody wey receive and bilive en name, e go give dem di rite to bi God pikin.
JOH 1:13 Dem go bi God shidren, nor bi as dia papa and mama take born dem from belle, or bikos somebody make dem so, but bikos God ensef make dem en own shidren.
JOH 1:14 Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
JOH 1:15 John kon bigin shaut sey, “Dis na di pesin wey I tell una about sey, ‘Di pesin wey go kom afta mi, big pass mi, bikos e dey before mi.’ ”
JOH 1:16 Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.
JOH 1:17 Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.
JOH 1:18 Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.
JOH 1:19 Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”
JOH 1:20 E ansa dem, “I nor dey lie, bikos nor bi mi bi di Christ.”
JOH 1:21 Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?” E kon sey, “No, I nor bi Elijah.” Dem ask am again, “Yu bi di profet?” E ansa, “No o-o!”
JOH 1:22 Again, dem ask am, “Who yu bi sef? Make yu tell us, so dat wi go know wetin to tell di pipol wey send us. Who yu sey yu bi?”
JOH 1:23 John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
JOH 1:24 (Na di Farisee pipol send dis pipol go meet John).
JOH 1:25 Dem kon ask John sey, “Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”
JOH 1:26 John ansa dem, “I dey baptize pipol with wota, but among una, one pesin dey wey una nor know.
JOH 1:27 E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”
JOH 1:28 All dis tins happen for Betany where pipol dey cross Jordan River kom meet John, make e baptize dem.
JOH 1:29 Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
JOH 1:30 Na dis pesin I tell una sey, “Afta mi, one man wey big pass mi go kom, bikos e dey before mi.
JOH 1:31 Misef nor know am before, but I dey baptize pipol with wota, so dat God go show Israel pipol who Jesus bi.”
JOH 1:32 Den John bear witness sey, “I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head.
JOH 1:33 I nor know am before, but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey, ‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’
JOH 1:34 I don si am and I bear witness sey, ‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”
JOH 1:35 Wen day break, John with en two disciple stand for outside.
JOH 1:36 Dem kon dey look Jesus wen e dey waka pass, den John kon sey, “Make una look! Na dat pesin bi God Sheep.”
JOH 1:37 Wen John two disciples hear wetin e tok, dem kon follow Jesus.
JOH 1:38 Jesus look back kon si di disciples dey follow am. Den e ask dem, “Wetin una wont?” Dem ansa am, “Oga God, (wey mean Tisha) where yu dey stay?”
JOH 1:39 Jesus ansa dem, “Make una kom si am.” So dem go si di place wey e dey stay kon stay with am dat day. Dat time na about for oklok for aftanoon.
JOH 1:40 Andru, Simon Pita broda, na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus.
JOH 1:41 E first go find en broda Simon kon tell am, “Wi don si di Mezaya”, (wey mean Christ).
JOH 1:42 Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”
JOH 1:43 Wen day break, Jesus kon plan to go Galilee. Wen e si Filip, e tell am, “Make yu follow mi.”
JOH 1:44 Filip na from Betsaida, wey bi Andru and Pita home-town.
JOH 1:45 Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”
JOH 1:46 Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?” Filip ansa am, “Make yu kom si.”
JOH 1:47 Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”
JOH 1:48 Netanel ask am, “How yu take know mi.” Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”
JOH 1:49 Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
JOH 1:50 Jesus tell am, “Bikos I tell yu sey I si yu under di fig tree, yu bilive wetin I tok? Bikos yu bilive, yu go si wetin big pass dis one.”
JOH 1:51 Den e kon sey, “Wetin I dey tell una na true word, una go si heaven open and God angels go dey waka up-and-down on-top God Pikin.”
JOH 2:1 Wen three days don pass, Mary, wey bi Jesus mama, go one marriage for Kana, wey dey for Galilee.
JOH 2:2 Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.
JOH 2:3 Wen wine finish, Jesus mama kon tell am, “Dia wine don finish.”
JOH 2:4 Jesus ansa am, “Mama, why yu dey tell mi? My time neva rish.”
JOH 2:5 So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”
JOH 2:6 For dat place, six big wota pot dey and only one fit kontain about twenty to thirty gallon for wota, wey di Jew pipol dey use wosh leg as dia tradishon tok.
JOH 2:7 Jesus tell di savants, “Make una full di pots with wota.” So dem kon full all di pot with wota.
JOH 2:8 Jesus tell dem, “Make una take some wota from di pot go give di chairman for di party.” So, dem do as e tok.
JOH 2:9 Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know), e koll di man wey dey marry kon tell am sey,
JOH 2:10 “Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”
JOH 2:11 Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.
JOH 2:12 Den Jesus with en mama, brodas and en disciples kon go Kapanaum. Dem kon stay der for some days.
JOH 2:13 By dis time, di Jew Passova Feast don near well-well, so Jesus kon go Jerusalem.
JOH 2:14 E si di pipol dey sell melu, sheep and dove inside di temple yard and e still si pipol wey dey shange money, sidan near dia tabol.
JOH 2:15 So e use koboko wey e make, take drive dem with dia sheep and melu komot from di temple yard. E trowey di tabol wey di pipol dey take shange money and dia money kon skata.
JOH 2:16 E kon tell di pipol wey dey sell dove, “Make una karry all dis tins komot for here. Make una nor turn my Papa house to market.”
JOH 2:17 Den en disciples kon remember as den rite for Psalms Book sey, “Di love wey e get for en Papa house dey burn for en heart like fire.”
JOH 2:18 Di Jew oga dem kon ask am, “As yu dey do all dis tins, na wish sign yu go show us make wi for fit bilive yu?”
JOH 2:19 Jesus ansa dem, “Even if una distroy dis Temple, for three days time, I go build am again.”
JOH 2:20 Den di Jew oga dem tell am, “Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?”
JOH 2:21 But na di temple for Jesus body naim e dey tok about.
JOH 2:22 So wen Jesus don wake-up from deat, en disciples kon remember sey, e tok so before. Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.
JOH 2:23 Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast. For der, many pipol kon bilive am, bikos dem si di mirakles wey e do.
JOH 2:24 But Jesus nor gri open en mind give di pipol, bikos e know dem well-well.
JOH 2:25 E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.
JOH 3:1 E get one man wey bi Farisee, en name na Nikodimos and e bi memba for di kansol wey dey rule Jew pipol.
JOH 3:2 E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.”
JOH 3:3 Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”
JOH 3:4 Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?”
JOH 3:5 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom.
JOH 3:6 Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi.
JOH 3:7 So, make yu nor konfuse bikos I tok sey, ‘God go born yu for di sekond time.’
JOH 3:8 Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, yu dey hear di sound wey e dey make, but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”
JOH 3:9 Nikodimos kon ask am, “How dis tins go fit happen?”
JOH 3:10 Jesus ansa, “Yu bi tisha for Israel, yet yu nor fit undastand dis tins?
JOH 3:11 Make I tell yu di trut, wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witness for wetin wi don si with awa eyes, but una nor gri asept wetin wi tok.
JOH 3:12 Naw, if I dey tell una about di tins wey dey for dis world and una nor fit bilive wetin I tok, how una go fit take bilive mi, if I bigin dey tell una about di tins wey dey for heaven?
JOH 3:13 Nobody don go heaven before, escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der.
JOH 3:14 Yu si, as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert, na so too dem go karry Man Pikin up,
JOH 3:15 so dat anybody wey bilive am, go get life wey nor dey end.
JOH 3:16 “God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
JOH 3:17 God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.
JOH 3:18 Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name.
JOH 3:19 Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
JOH 3:20 Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.
JOH 3:21 But di pesin wey dey do good tins, dey kom out for lite, so dat pipol go si di tins wey e dey do, bikos na as God wont naim e dey do.”
JOH 3:22 Leta, Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol.
JOH 3:23 John dey baptize for Aenon, one town wey near Salim, bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem.
JOH 3:24 (For dis time, dem neva put John for prison).
JOH 3:25 Den one Jew man kon dey argue with John disciples about how dem suppose to wosh dia body as dia tradishon tok.
JOH 3:26 Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”
JOH 3:27 John ansa dem, “Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven, gi-am.
JOH 3:28 Unasef go fit bear witness sey, I tok sey I nor bi di Christ, but God send mi kom, before Christ go kom.
JOH 3:29 Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.
JOH 3:30 Pipol must know Christ pass as dem know mi.
JOH 3:31 “Di pesin wey kom from heaven betta pass evribody wey dey for dis world. And who dey dis world, dey tok about di tins wey dey inside di world.
JOH 3:32 But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven, but pipol nor gri listin to am.
JOH 3:33 But pesin wey bilive wetin e tok about God, bilive sey wetin God tok, na true.
JOH 3:34 Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol.
JOH 3:35 God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.
JOH 3:36 Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
JOH 4:1 Jesus kon know sey di Farisee pipol don hear sey e dey baptize plenty pipol pass John and di pipol dey follow am,
JOH 4:2 (aldo nor bi Jesus ensef dey baptize pipol, but na en disciples dey do am).
JOH 4:3 Jesus komot for Judea dey go Galilee.
JOH 4:4 For am to rish der, e go must pass thru Samaria.
JOH 4:5 E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin.
JOH 4:6 Jakob well dey der too. Dat aftanoon, bikos Jesus don taya to waka, e kon sidan near di well.
JOH 4:7 So one woman for di town kom draw wota for di well. Jesus tell am, “Abeg give mi wota make I drink.”
JOH 4:8 By dis time, en disciples don go inside di town go buy food.
JOH 4:9 Den di woman kon tell Jesus, “How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, ‘Make I give yu wota drink?’ ” (E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)
JOH 4:10 Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
JOH 4:11 Di woman ask am, “Oga God, yu nor get bucket and di well deep well-well, where yu go fit get dat kind wota?
JOH 4:12 Yu big pass awa grand-grand papa Jakob wey give us dis well, where en family and animals dey drink from?”
JOH 4:13 Jesus ansa, “Pesin wey drink from dis wota go always dey hongry for wota.
JOH 4:14 But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
JOH 4:15 Di woman kon tell am, “Oga God, give mi dis wota, so dat I nor go hongry for wota or kom here kon draw wota again.”
JOH 4:16 Jesus tell am, “Go koll yor husband, make two of una kom meet mi.”
JOH 4:17 Di woman ansa, “I nor get husband.” Den Jesus kon tell am, “Yu tok true wen yu sey ‘I nor get husband.’
JOH 4:18 Bikos yu don marry five husband before and di man wey yu dey stay with naw, nor bi yor real husband. Na true yu tok.”
JOH 4:19 Di woman kon tell am, “Oga God, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen.
JOH 4:20 Awa papa dem serve God for dis mountin, but una kon tok sey, di place wey pipol suppose to woship God, na Jerusalem e dey.”
JOH 4:21 Jesus kon sey, “Woman, make yu bilive mi, di time dey kom, wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey, nor bi only for dis mountin or for Jerusalem.
JOH 4:22 Una dey serve wetin una nor know, but wi dey serve wetin wi know, bikos na Jew pipol, naim God first koll to ensef.
JOH 4:23 But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem.
JOH 4:24 God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”
JOH 4:25 Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”
JOH 4:26 Jesus kon tell am, “Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya.”
JOH 4:27 Wen Jesus dey tok to di woman, en disciples kon kom back. Dem sopraiz sey e dey tok with one woman, but dem nor fit ask am, “Wetin e wont?” or “Why e dey tok to di woman?”
JOH 4:28 By dis time, di woman don leave en pot wey e take kom draw wota kon run go inside di town go tell pipol sey,
JOH 4:29 “Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”
JOH 4:30 So di pipol kom out for di town go meet Jesus.
JOH 4:31 By dis time, di disciples kon beg am, “Tisha, make yu chop sometin naw.”
JOH 4:32 But e tell dem, “I get food wey I go chop wey una nor know about.”
JOH 4:33 Di disciples kon dey ask demsef, “Abi somebody don bring sometin for am to chop wen wi nor dey here?”
JOH 4:34 Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.
JOH 4:35 Nor bi una dey tok sey, ‘Na for monts remain before dem go plok fruit wey dem plant for farm?’ Make una look round and una go si sey fruit don ripe rish to plok.
JOH 4:36 God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.
JOH 4:37 Dis one show sey, di tin wey pipol dey tok sey, ‘One pesin plant and anoda pesin plok di fruit’, na true word.
JOH 4:38 I send una go plok wetin una nor plant. Oda pipol don sofa plant dem, but una kon enjoy wetin dem sofa for.”
JOH 4:39 By dis time, many pipol from Samaria town kon bilive am, bikos of di tins wey di woman tok, “E tell mi all di tins wey I don do.”
JOH 4:40 Wen Samaria pipol kom meet am, dem kon dey beg am sey, make e stay with dem. So e kon stay der for two days,
JOH 4:41 and bikos of wetin e tok, many pipol kon bilive am.
JOH 4:42 Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”
JOH 4:43 Wen two days pass, Jesus komot from der go Galilee.
JOH 4:44 (Bikos Jesus don tok am sey, “Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-town”).
JOH 4:45 Wen e rish Galilee, di pipol wey dey der kon welkom am, bikos dem don si all di tins wey e do for Jerusalem for di time wen dem dey do Passova Feast.
JOH 4:46 Again, e go Kana wey dey Galilee, for where e first turn wota to wine. For Kapanaum, one soja-man wey dey work for di king palis dey der and en pikin wey nor well.
JOH 4:47 Wen e hear sey Jesus don kom back to Galilee, e go meet am kon beg am sey make e kom heal en pikin wey won die.
JOH 4:48 So Jesus ask am, “If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”
JOH 4:49 Di man ansa, “Oga God, abeg make yu kom before my pikin go die.”
JOH 4:50 Jesus kon tell am, “Make yu go house, yor pikin nor go die.” Di man bilive wetin Jesus tell am, so e kon komot go en house.
JOH 4:51 Wen e don near house, en savants kon meet, tell am sey, “Yor pikin don well, e nor die.”
JOH 4:52 So, e ask dem di time wen di pikin bigin dey betta. Dem kon tell am, “Na yestiday for one oklok for aftanoon naim e well.”
JOH 4:53 Bikos of wetin dem tok, di pikin papa kon remember sey dat na di time wen Jesus tell am sey, “Yor pikin nor go die.” Bikos of dis, di man and evribody wey dey en house kon bilive Jesus.
JOH 4:54 Dis na di sekond mirakle wey Jesus do for Galilee, afta e kom back from Judea.
JOH 5:1 Jesus kon go one feast wey dem dey do for Jerusalem.
JOH 5:2 One pool dey der wey near di Sheep Gate, di name na Betsaida for Aramaik language. Na five roads pipol take dey enter inside.
JOH 5:3 Pipol wey nor well, wey blind and doz wey nor fit waka dey liedan for di difren roads.
JOH 5:4 From time to time, one angel dey kom shake di wota and anybody wey first enter di wota afta di angel don shake am, go well.
JOH 5:5 One man dey der wey nor fit waka for thirty-eight years.
JOH 5:6 Wen Jesus si am liedan for der, e kon know sey di man neva fit waka for long time. So, Jesus kon ask am, “Yu won waka?”
JOH 5:7 Di man ansa am, “Oga God, I nor get anybody wey go put mi inside di pool wen di wota dey shake. Anytime I dey try to enter di wota, anoda pesin go kwik enter before I rish der.”
JOH 5:8 Jesus tell am, “Make yu get up! Karry yor mat make yu bigin waka.”
JOH 5:9 At wons, di man get up, karry en mat kon bigin waka. (Dat day na Sabat).
JOH 5:10 Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”
JOH 5:11 Naim e ansa dem, “Di man wey make mi well, tell mi sey, ‘Make I karry my mat and make I bigin waka.’ ”
JOH 5:12 Dem kon ask am, “Who bi di man wey sey, ‘Make yu karry yor mat, make yu dey waka?’ ”
JOH 5:13 But di man nor know who e bi, bikos Jesus don komot der and plenty pipol dey for dat place.
JOH 5:14 Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.”
JOH 5:15 Di man kon go tell di Jew oga dem sey, “Na Jesus bi di pesin wey make mi well.”
JOH 5:16 Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am.
JOH 5:17 So e tell dem, “My Papa dey work evritime and na so mi too dey work.”
JOH 5:18 Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.
JOH 5:19 Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.
JOH 5:20 Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.
JOH 5:21 As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die, na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give.
JOH 5:22 Di Papa nor dey judge anybody, but e don give en pikin pawa to judge evribody,
JOH 5:23 so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
JOH 5:24 “I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.
JOH 5:25 I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.
JOH 5:26 Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too.
JOH 5:27 Di Papa don give en pikin di pawa to judge pipol.
JOH 5:28 “So, make dis word nor sopraiz una, bikos di time dey kom, wen all doz wey dey inside grave go hear di pikin vois,
JOH 5:29 and di angels go kon separate di pipol wey do good tins, so dat dem go enter life wey nor dey end, but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins.
JOH 5:30 I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
JOH 5:31 “If I tok about mysef, e fit bi sey wetin I tok nor bi true”,
JOH 5:32 bikos anoda pesin dey wey go tok about mi and I know sey wetin e tok about mi, na true.
JOH 5:33 “Una don send message go meet John and e don tell una true word.
JOH 5:34 (I nor dey trust wetin pipol tok, but I dey tell una dis word make God for save una.)
JOH 5:35 John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”
JOH 5:36 But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.
JOH 5:37 And my Papa wey send mi, en ensef don bear witness about mi. Una neva hear my Papa vois or si am before.
JOH 5:38 En word neva still dey inside una, bikos una nor bilive sey na-im send mi.
JOH 5:39 Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,
JOH 5:40 but una nor ready to kom meet mi, so dat una go get life wey nor dey end.
JOH 5:41 “I nor like make pipol dey praiz mi,
JOH 5:42 bikos I know sey, una nor love God for inside una heart.
JOH 5:43 I kom with my Papa name and una nor gri asept mi, but if anoda pesin kom with en own name, una go asept am.
JOH 5:44 How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.
JOH 5:45 “Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite, wey una dey put hope for.
JOH 5:46 If una bilive wetin Moses rite for di law, una suppose to bilive mi too, bikos na mi e rite about.
JOH 5:47 But if una nor bilive wetin Moses rite, how una go take bilive wetin I dey tell una naw?”
JOH 6:1 Wen Jesus don tok finish, e kon cross go Tiberias wey dey di oda side for Galilee wotaside.
JOH 6:2 Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.
JOH 6:3 Jesus komot for der go di mountin side kon sidan der with en disciples.
JOH 6:4 (Dat time, Passova Feast don rish.)
JOH 6:5 Wen Jesus look up, e si plenty pipol dey kom meet am. Den e ask Filip, “Na where wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?”
JOH 6:6 Jesus tok dis one make e for si wetin Filip go do, bikos en ensef know wetin e won do.
JOH 6:7 Filip ansa, “Even if wi buy bread wey rish two hundred silva koins and if dem share am small-small, e nor go rish evribody chop.”
JOH 6:8 Anoda disciple wey en name bi Andru, wey bi Simon Pita broda kon tell Jesus sey,
JOH 6:9 “One boy dey here wey get five bread and two fish, but dis one nor go rish dis plenty pipol chop at-all!”
JOH 6:10 Jesus ansa, “Tell all di pipol make dem sidan” (as plenty grass dey di place wey dem go fit sidan put). Di men wey sidan, rish 5,000.
JOH 6:11 Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.
JOH 6:12 Wen evribody don beleful, Jesus kon tell en disciples, “Make una gada wetin remain, make anytin nor waste.”
JOH 6:13 Wen dem gada wetin dem chop remain for di five bread, e full twelf basket.
JOH 6:14 So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”
JOH 6:15 Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king, only en kon komot go on-top di mountin alone.
JOH 6:16 Wen evening rish, en disciples kon go wotaside go wait am,
JOH 6:17 dem enter one kenu, cross go Kapanaum (by dis time, evriwhere don dey dark and Jesus neva kom meet dem.)
JOH 6:18 Den strong breeze bigin blow and di river kon dey rof well-well.
JOH 6:19 Wen dem don padol di kenu go rish about three or for mile, dem si Jesus dey waka on-top di wota dey kom near dem. Fear kon katch dem well-well.
JOH 6:20 Jesus tell dem, “Na mi, make una nor fear.”
JOH 6:21 As dem dey try make e enter inside di kenu, dem kon si sey di kenu don rish where dem dey go.
JOH 6:22 Wen day don break, di pipol wey dey di oda side for di river know sey na only one small kenu dey der. Dem still know sey Jesus enter di kenu with dem.
JOH 6:23 So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray.
JOH 6:24 So wen di pipol si sey Jesus and en disciples nor dey der, dem enter di kenu kon go look for Jesus for anoda town wey dem dey koll Kapanaum.
JOH 6:25 Wen dem si Jesus for di oda side for di river, dem ask am, “Tisha, wish time yu kom here?”
JOH 6:26 Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi, nor bi bikos of di mirakles wey una si.
JOH 6:27 Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”
JOH 6:28 Dem kon ask am, “Wetin wi go do to make God happy with us?”
JOH 6:29 Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”
JOH 6:30 Dem still ask Jesus, “Wish kind mirakle yu go do make wi si, make wi for bilive yu?
JOH 6:31 Awa grand-grand papa dem chop manna for wildaness as dem rite for God word sey, ‘God give dem bread from heaven to chop.’ ”
JOH 6:32 Den Jesus tell dem, “Make I tell una true word, nor bi Moses give una bread from heaven, but God, wey bi my Papa, na-im give una di true bread from heaven.
JOH 6:33 God bread na di pesin wey kom down from heaven kon give betta life to di pipol wey dey dis world.”
JOH 6:34 So dem tell am, “Oga God, from naw go, make yu give us dis bread.”
JOH 6:35 Jesus kon tell dem, “Na mi bi di bread wey dey give life. Pesin wey kom meet mi nor go hongry lie-lie and di pesin wey bilive mi, nor go hongry for wota again.
JOH 6:36 As I don tell una, una dey si mi, but una nor bilive.
JOH 6:37 Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am.
JOH 6:38 Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven, but na to do wetin my Papa wont.
JOH 6:39 Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day.
JOH 6:40 Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”
JOH 6:41 Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus, bikos e tok sey, “Na mi bi di bread wey kom down from heaven.”
JOH 6:42 Den dem sey, “Dis Jesus sef nor bi Josef pikin, wey wi know en papa and mama? Na how e kon dey tok sey, ‘I kom down from heaven?’ ”
JOH 6:43 Jesus ansa, “Make una nor komplain about mi give each oda.
JOH 6:44 Nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day.
JOH 6:45 Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.
JOH 6:46 (Nor bi sey anybody don si di Papa before, escept mi wey kom from heaven).
JOH 6:47 I dey tell una true word, anybody wey bilive mi, don get life wey nor dey end.
JOH 6:48 Na mi bi di bread wey dey give pesin life.
JOH 6:49 Una grand-grand papa dem chop manna for wildaness, but dem still die.
JOH 6:50 Dis na di bread wey kom from heaven, so dat anybody wey chop am, go get life wey nor dey end.
JOH 6:51 Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”
JOH 6:52 Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey, “How dis man go give us en flesh make wi chop?”
JOH 6:53 Jesus tell dem, “I dey tell una true word, unless una chop Man Pikin flesh and drink en blood, una nor go get life for inside una.
JOH 6:54 Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.
JOH 6:55 My flesh na di real food and my blood na di korrect drink.
JOH 6:56 Di pesin wey chop my flesh and drink my blood, go stay inside mi and I go dey inside am too.
JOH 6:57 Na my Papa wey dey for heaven send mi and as I dey for dis life bikos of am, na so di pesin wey chop my flesh go get life, bikos of mi.
JOH 6:58 Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”
JOH 6:59 Jesus tok dis tins wen e dey tish dem for inside di temple for Kapanaum.
JOH 6:60 Wen Jesus many disciples hear wetin e tok, dem kon sey, “Dis tin wey Jesus dey tok so hard well-well o-o! Na who go fit undastand dem?”
JOH 6:61 Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too?
JOH 6:62 Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before?
JOH 6:63 Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life.
JOH 6:64 But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)
JOH 6:65 So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”
JOH 6:66 Afta dis, Jesus many disciples kon stop to follow am.
JOH 6:67 Den Jesus ask en twelf disciples, “Una won go too?”
JOH 6:68 Den Simon Pita ansa am, “Oga God, na who wi go kon go meet? Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end.
JOH 6:69 Wi don bilive and know sey, ‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”
JOH 6:70 Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”
JOH 6:71 (E tok dis one about Judas, wey bi Simon Iskariot pikin, bikos na dis Judas, wey bi one among en twelf disciples, naim go sell am give en enemy.)
JOH 7:1 Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am.
JOH 7:2 Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast.
JOH 7:3 Jesus brodas kon dey tell am, “Komot for here go Judea, make yor disciples si di mirakles wey yu dey do.
JOH 7:4 Bikos anybody wey wont make pipol sabi who e bi, nor go do anytin for korna. Since yu dey do dis tins, e good sey make yu show yorsef to evribody.”
JOH 7:5 (Even en brodas nor bilive wetin Jesus dey do.)
JOH 7:6 Jesus ansa dem, “Time neva rish for mi to go, but una fit go anytime una like.
JOH 7:7 Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.
JOH 7:8 Make una go di feast, I nor go-go, bikos my time neva rish.”
JOH 7:9 Afta e don tok finish, e kon stay for Galilee.
JOH 7:10 But wen en brodas don go di feast, Jesus kon go der too, but e nor let anybody know sey e dey der.
JOH 7:11 Di Jew oga dem kon dey ask pipol, “Where e dey?”
JOH 7:12 Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”
JOH 7:13 But nobody fit tok out, bikos dem dey fear di Jew oga dem.
JOH 7:14 Wen di feast don rish half, Jesus enter di temple kon dey tish.
JOH 7:15 Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey, “How e take know dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go skool at-all?”
JOH 7:16 Jesus ansa dem, “Wetin I dey tish nor bi my own, but na di Pesin wey send mi, na-im give mi.
JOH 7:17 Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.
JOH 7:18 Anybody wey dey tok with en own pawa, go wont make pipol praiz am, but di pesin wey won honor who send am, naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am.
JOH 7:19 Moses nor give una di law? But una nor gri obey am. Why e bi sey una won kill misef?”
JOH 7:20 Di pipol ansa Jesus, “Demon don enter yor body! Who won kill yu?”
JOH 7:21 Den Jesus ansa, “Na one mirakle wey I do so, make una dey sopraiz?
JOH 7:22 Na true sey Moses tell una to sekonsaiz una son, (nor bi Moses start am, na from Abraham time e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day.
JOH 7:23 Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day?
JOH 7:24 Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”
JOH 7:25 Some pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey, “Dis nor bi di man wey dem won kill?
JOH 7:26 Naim dey here dey tok for publik so and dem nor fit tell am anytin. Abi di oga dem don gri sey naim bi di Christ?
JOH 7:27 Wisef know di place where dis man from kom and wi know sey anytime wey Christ go kom, nobody go fit know where e go kom from.”
JOH 7:28 As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.
JOH 7:29 But I know am well-well, bikos na from am, I kom and naim send mi.”
JOH 7:30 Dem kon try to katch Jesus, but nobody fit tosh am, bikos en time neva rish.
JOH 7:31 Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”
JOH 7:32 Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus, dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.
JOH 7:33 Jesus kon tell dem, “I go only stay with una for small time and afta, I go-go meet di Pesin wey send mi.
JOH 7:34 Una go dey look for mi, but una nor go si mi and una nor go fit kom meet mi for where I dey.”
JOH 7:35 Den di Jew oga dem kon dey ask each oda, “Where e won go wey wi nor go fit si am, abi e won go tish Jew pipol wey dey stay with Greek pipol?
JOH 7:36 Wetin e mean wen e tok sey, ‘Una go look for mi, but una nor go si mi and where I dey, una nor go fit kom der?’ ”
JOH 7:37 For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi.
JOH 7:38 Di pesin wey bilive mi and wetin I tok, make e kom drink, just as God word sey, ‘Plenty wota wey dey give life, go flow from inside en belle.’ ”
JOH 7:39 (E tok dis tin about di Spirit wey di pipol wey bilive am go get, bikos by dis time, God neva give en Spirit to pipol, bikos E neva honor Jesus Christ.)
JOH 7:40 Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
JOH 7:41 Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.
JOH 7:42 Abi God word nor sey, ‘Christ go kom from David family wey dey Betlehem, di village wey David from kom?’ ”
JOH 7:43 So di pipol kon divide bikos of Jesus.
JOH 7:44 Some of dem kon dey try to katch am, but nobody fit take hand tosh am.
JOH 7:45 Wen di sojas go back, di priest oga dem and Farisee pipol kon ask dem, “Why una nor katch Jesus kom?”
JOH 7:46 Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”
JOH 7:47 Den di Farisee pipol kon ask di sojas, “Abi, e don deceive una too?
JOH 7:48 Abi any of us wey bi Farisee pipol or priests don bilive Jesus?
JOH 7:49 Curse dey dis pipol head, bikos dem nor know di law.”
JOH 7:50 Den one man wey en name bi Nikodimos, wey don first go meet Jesus and wey bi one of di big oga dem kon sey,
JOH 7:51 “Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do, abi nor bi so?”
JOH 7:52 Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”
JOH 7:53 Afta dis, evribody bigin go en house.
JOH 8:1 Den Jesus waka enter Mount Olives.
JOH 8:2 For early morning, e enter di temple. Plenty pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem.
JOH 8:3 Di pipol wey sabi di law and di Farisee pipol kon bring one woman wey dem katch sey e sleep with man wey nor bi en husband. Dem kon make am stand for dia front,
JOH 8:4 den dem tell Jesus, “Tisha, wi katch dis woman wen e dey sleep with one man wey nor bi en husband.
JOH 8:5 Moses Law sey, ‘Make dem stone dis kind woman die.’ Wetin yu get to tok for dis matter?”
JOH 8:6 (Dem ask am dis kweshon to set trap for am, make dem for fit katch am). But Jesus bend down kon take en finger dey rite sometin for groun.
JOH 8:7 Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.”
JOH 8:8 E kon bend down again bigin rite for groun.
JOH 8:9 Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.
JOH 8:10 Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipol wey bring yu? Nobody remain to kondemn yu?”
JOH 8:11 Di woman ansa, “Oga God, nobody remain.” Den Jesus tell am, “Mi too nor go kondemn yu. But from naw go, make yu nor sin again.”
JOH 8:12 Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”
JOH 8:13 Di Farisee pipol kon dey argue with am sey, “Yu dey tok about yorsef and wetin yu tok, nor bi true.”
JOH 8:14 Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go.
JOH 8:15 Una dey judge pesin with wetin una si with una eye, but I nor dey judge pipol like dat.
JOH 8:16 But, if I sey pesin do bad, di tins wey I si and tok about, na true, as e bi sey nor bi only mi dey tok am. Na mi and my Papa wey send mi, dey tok am togeda.
JOH 8:17 God word sey, ‘Wetin two pipol bear witness about, na true.’
JOH 8:18 I dey bear witness about mysef and my Papa wey send mi, dey bear witness about mi too.”
JOH 8:19 Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?” Jesus ansa dem, “Una nor know mi or my Papa, if to sey una know mi, una for know my Papa too.”
JOH 8:20 Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money, wey dey inside di temple. Nobody fit katch am, bikos en time neva rish.
JOH 8:21 Den Jesus kon tell dem again, “I dey go and una go look for mi, but una go die inside una sin. Where I dey go, una nor go fit kom der.”
JOH 8:22 So di Jew oga dem kon dey ask, “Abi e won go kill ensef? As e dey tok sey, ‘Where I dey go, una nor go fit kom der?’ ”
JOH 8:23 Jesus ansa dem, “Na groun una from kom, but mi, na heaven I from kom. Una kom from dis world, but I nor kom from dis world.
JOH 8:24 Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”
JOH 8:25 Den dem ask am, “Who yu bi sef?” Jesus ansa, “Na wetin I tell una from di biginnin.
JOH 8:26 I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”
JOH 8:27 (But dem nor undastand sey e dey tok about en Papa for heaven).
JOH 8:28 Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.
JOH 8:29 And di Pesin wey send mi dey with mi. E nor dey leave mi, bikos I always dey do di tins wey E wont.”
JOH 8:30 As e dey tok, many pipol kon bilive am.
JOH 8:31 Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples
JOH 8:32 and una go know di trut and di trut go free una.”
JOH 8:33 Dem tell am, “All of us na Abraham pikin, wi neva bi slave to anybody before. Why yu dey sey, wi go dey free?”
JOH 8:34 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.
JOH 8:35 Pesin wey bi slave nor dey stay for inside dat family forever, but pesin wey bi pikin for di family, naim dey stay forever.
JOH 8:36 So wen Man Pikin free una, una don dey free bi dat.
JOH 8:37 I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.
JOH 8:38 Na wetin I si wen I dey with my Papa, naim I dey tell una, so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”
JOH 8:39 Dem tell am, “Na Abraham bi awa papa.” Den Jesus ansa dem, “If una bi Abraham pikin, una for dey do di tins wey Abraham do.
JOH 8:40 But una won kill mi, bikos I tell una di real trut wey I hear from God. Abraham nor do wetin una dey do so o-o.
JOH 8:41 Una dey do di tins wey una papa do.” Dem kon tell Jesus, “Awa papa nor born us for outside marriage. Na God ensef bi di papa wey wi get.”
JOH 8:42 Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.
JOH 8:43 Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.
JOH 8:44 Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
JOH 8:45 Na bikos I dey tell una true word, naim make una nor gri bilive mi.
JOH 8:46 Who among una go fit show sey I kommit sin? Since I dey tell una true word, why una nor won bilive mi?
JOH 8:47 Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”
JOH 8:48 So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”
JOH 8:49 Jesus kon tell dem, “I nor get demon. I dey respet my Papa, but una nor gri respet mi.
JOH 8:50 I nor wont make una praiz mi, but na God, di One wey dey heaven, na-im wi suppose praiz and E go judge evribody for di korrect way.
JOH 8:51 I dey tell una true word, if anybody follow wetin I dey tish, e nor go die again.”
JOH 8:52 Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’
JOH 8:53 Yu big pass awa papa Abraham and all di profets wey don die? Who yu tink sey yu bi sef?”
JOH 8:54 Jesus ansa, “If I dey praiz mysef, my praiz na yeye one. Di pesin wey dey praiz mi na my Papa, wey una dey sey, ‘Na-im bi awa God.’
JOH 8:55 Una nor know am, but I know am and if I sey I nor know am, I dey lie like una. I know am and I dey follow wetin e dey tok.
JOH 8:56 Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.”
JOH 8:57 Den di pipol ask am, “Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?”
JOH 8:58 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!”
JOH 8:59 Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.
JOH 9:1 Wen Jesus dey waka pass, e kon si one man wey blind from di time wey en mama born am.
JOH 9:2 En disciples ask am, “Tisha, na wish pesin sin, wey make dis man blind since di time en mama born am? Na di man or na en papa and mama?”
JOH 9:3 Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.
JOH 9:4 I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work.
JOH 9:5 As far as I dey inside dis world, na mi bi di lite for di world.
JOH 9:6 “Afta e tok finish, e spit for groun kon take di san-san wey e spit put take rub di blind man eye.
JOH 9:7 Den e tell am, Make yu go wosh yor face inside di pond wey dem dey koll Siloam (dis name mean ‘Send’).” So di blind man kon go wosh en face as Jesus tell am. As e dey kom back, e kon bigin si.
JOH 9:8 Den en neighbours and oda pipol wey dey si am dey beg before, kon ask sey, “Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for money?”
JOH 9:9 Some pipol ansa, “Na-im o-o!” Odas tok sey, “Nor bi en, but e look like am.” Di man ensef kon sey, “Na mi bi di pesin.”
JOH 9:10 Dem ask am, “Wetin happen wey make yu bigin si?”
JOH 9:11 E ansa dem, “Na di man wey dem dey koll Jesus take san-san wey e spit put rub my eye. Den e tell mi sey, ‘Make yu go Siloam go wosh yor face.’ Afta I go wosh my face for di pond, I kon bigin si.”
JOH 9:12 Naim dem ask am, “Where di man dey?” E ansa dem, “I nor know o-o.”
JOH 9:13 Dem take di man wey blind before go meet di Farisee pipol,
JOH 9:14 (bikos na for Sabat Day Jesus spit for san-san take rub di blind man eye).
JOH 9:15 Naim di Farisee pipol ask am again, “How yu take bigin si?” E ansa dem, “E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si.”
JOH 9:16 Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.
JOH 9:17 Dem ask di man wey blind before sey, “Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?” Di man ansa, “Na profet e bi.”
JOH 9:18 Di Jew oga dem nor gri bilive sey, true-true di man blind before, so dem kon koll en papa and mama.
JOH 9:19 Dem ask dem, “Na una pikin bi dis? Na true sey e blind wen una born am? How e kon take dey si naw?”
JOH 9:20 So en papa and mama ansa, “Wi know sey dis na awa pikin and e blind wen wi born am.
JOH 9:21 But wi nor know how e take bigin si or even who open en eye. Make una ask am, e don big rish to tok for ensef.”
JOH 9:22 (En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.”
JOH 9:23 Na dis one make en papa and mama sey, “Make dem ask am, bikos e don big rish to tok for ensef).”
JOH 9:24 So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”
JOH 9:25 Man ansa dem, “Weda na sina e bi, I nor know! But wetin I know bi sey, before I blind, but naw, I don dey si.”
JOH 9:26 So dem ask am again, “Wetin e do? How e take make yu dey si sef?”
JOH 9:27 E kon ansa dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disciples too?”
JOH 9:28 Dem shaut for di man kon sey, “Na yu bi en disciple. Wi bi Moses disciples.
JOH 9:29 Wi know sey God tok to Moses, but wi nor know where dis man from kom.”
JOH 9:30 Di man kon sey, “I sopraiz for una o-o. Una nor know where e from kom, but na-im open my eye!
JOH 9:31 Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin, but if pesin dey do wetin God tok, God go hear en prayer.
JOH 9:32 Wi neva hear before sey, anybody don fit make pesin wey blind si.
JOH 9:33 If God nor send dis man, e nor go fit do dis kind tin.”
JOH 9:34 Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.
JOH 9:35 Wen Jesus hear sey dem don drive di man komot, e go look for am kon ask am, “Yu bilive who Man Pikin bi?”
JOH 9:36 Di man kon sey, “Oga God, tell mi who e bi, make I for fit bilive am?”
JOH 9:37 Jesus ansa am, “Na-im dey here dey tok to yu so.”
JOH 9:38 Di man kon sey, “Oga God, I bilive.” Den e knee down kon woship Jesus.
JOH 9:39 Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”
JOH 9:40 Wen di Farisee pipol wey dey der hear wetin Jesus tok, dem kon ask am, “Yu tink sey wisef blind?”
JOH 9:41 Jesus ansa dem, “If una gri sey una blind, God nor go kondemn una bikos of una sin, but as una tok sey una dey si so, una sin dey for una head.”
JOH 10:1 “Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.
JOH 10:2 Di pesin wey pass di door enter, na-im bi di shepad wey dey guide di sheep.
JOH 10:3 Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out.
JOH 10:4 Wen e don bring all en sheep kom out, e go-go dia front and di sheep go follow am, bikos dem know en vois.
JOH 10:5 Dem nor go gri follow strenja, but dem go run from dem, bikos dem nor know di strenja vois.”
JOH 10:6 Jesus tell dem dis parabol, but dem nor undastand wetin e tok.
JOH 10:7 So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.
JOH 10:8 All di pipol wey kom before mi, na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem.
JOH 10:9 Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop.
JOH 10:10 Di tin wey tif dey do, na to tif, kill and distroy pipol, but mi, I kom so dat pipol go get life, di kind life wey full well-well.
JOH 10:11 “Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.
JOH 10:12 Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.
JOH 10:13 Bikos di pesin nor kare for di sheep, go run leave dem.
JOH 10:14 “Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.
JOH 10:15 Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.
JOH 10:16 I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.
JOH 10:17 Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi, bikos I ready to sakrifice my life, so dat I go fit get di life back again.
JOH 10:18 Nobody go fit take my life from mi, but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again. Dis na wetin God kommand mi to do.”
JOH 10:19 Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok.
JOH 10:20 Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”
JOH 10:21 Odas kon sey, “Di pesin wey get demon nor go fit tok like dis. No demon fit make blind pesin si.”
JOH 10:22 Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish.
JOH 10:23 Dat na di time wey rain dey fall (and kold dey strong well-well) and Jesus kon dey waka inside di varanda where Solomon for dey take breeze, wey dey inside di temple yard.
JOH 10:24 Di Jew oga dem gada round Jesus, kon ask am, “How long yu go make us dey wait? If na yu bi di Christ, make yu tell us.”
JOH 10:25 Jesus ansa dem, “I don tell una and una nor bilive. Di tin wey I take my Papa name dey do, dey bear witness for mi.
JOH 10:26 But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep.
JOH 10:27 My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.
JOH 10:28 I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.
JOH 10:29 My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand,
JOH 10:30 bikos mi and my Papa, na one.”
JOH 10:31 Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am.
JOH 10:32 So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”
JOH 10:33 Di Jew oga dem ansa, “Wi nor won stone yu bikos of di good tins, but na bikos yu wey bi ordinary pesin, dey make mout sey, yu bi God.”
JOH 10:34 Jesus ask dem, “Una law nor tok sey, I sey, ‘Una bi gods?’
JOH 10:35 If dem koll di pipol wey God send en word go meet, sey, ‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange,
JOH 10:36 Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey, Yu dey tok against God, bikos I sey, ‘I bi God Pikin?’
JOH 10:37 If I nor do di tins wey my Papa send mi, make una nor bilive mi.
JOH 10:38 But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”
JOH 10:39 So dem try again to katch am, but e kon waka leave dem.
JOH 10:40 Jesus go back kon cross Jordan River, where John for baptize pipol and e kon stay for der.
JOH 10:41 Many pipol kom meet Jesus for di place. Dem bigin dey sey, “Even doh John nor do any mirakle, but evritin wey e tok about Jesus, na true.”
JOH 10:42 And many pipol for di place kon bilive Jesus.
JOH 11:1 E get one man, en name na Lazarus and e nor well. En with Mary and Marta, en sistas kom from Betany.
JOH 11:2 Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair.
JOH 11:3 So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.
JOH 11:4 Wen Jesus hear di message, e kon sey, “Dis sickness nor go kill Lazarus. E go make God and en pikin get honor.”
JOH 11:5 (E klear sey Jesus love Marta, Mary and Lazarus well-well.)
JOH 11:6 Afta e hear sey Lazarus nor well, e stay where e dey for anoda two days.
JOH 11:7 Den e kon tell en disciples, “Make wi go back to Judea.”
JOH 11:8 But en disciples ask am, “Tisha, nor bi di place where di Jew pipol won for kill us yu sey make wi go again so?”
JOH 11:9 Jesus ansa, “Evriday get twelf hours wey lite dey take shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si well-well, as e bi sey lite dey.
JOH 11:10 But pesin wey waka for nite, go fit fall, bikos e nor get lite to si road.”
JOH 11:11 Den Jesus tell dem, “Awa friend Lazarus dey sleep, but I won go wake am up.”
JOH 11:12 Di disciples sey, “Oga God, if e just dey sleep, den e go wake-up.”
JOH 11:13 (Dem tink sey, wetin Jesus mean bi sey, Lazarus just dey sleep, but wetin e mean bi sey, Lazarus don die.)
JOH 11:14 So e tell dem sey, “Lazarus don die.
JOH 11:15 I happy sey I nor dey der, so dat una go get anoda shance to bilive mi. Make una kom make wi go si am.”
JOH 11:16 So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.”
JOH 11:17 Wen Jesus rish Betany, dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus.
JOH 11:18 (Betany na about two mile from Jerusalem,
JOH 11:19 and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)
JOH 11:20 So wen Marta hear sey Jesus dey kom, e kon waka go meet am, but Mary sidan for house.
JOH 11:21 Marta tell Jesus, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.
JOH 11:22 But I know sey, God go give yu anytin wey yu ask am.”
JOH 11:23 So Jesus tell am, “Yor broda go wake-up again.”
JOH 11:24 Den Marta sey, “I know sey e go wake-up again for di resureshon day.”
JOH 11:25 Jesus ansa am, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die
JOH 11:26 and di pesin wey bilive mi for dis life, nor go ever die. Marta, yu bilive wetin I tok so?”
JOH 11:27 Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”
JOH 11:28 Den Marta go meet Mary, en sista kon tok for en ear sey, “Di tisha dey here and e won si yu.”
JOH 11:29 Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go meet Jesus.
JOH 11:30 Jesus still dey outside di village wen Marta go meet am.
JOH 11:31 Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik, dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry, so dem follow am.
JOH 11:32 Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.”
JOH 11:33 Jesus kon si as Mary and di oda pipol dey kry. So e sorry for dem and di tin pain am well-well.
JOH 11:34 E kon ask dem, “Where una beri am put?” Den dem tell am, “Oga God, kom make wi show yu.”
JOH 11:35 Jesus kon kry.
JOH 11:36 Di pipol wey kom salot dem kon sey, “Jesus love dis man well-well o-o.”
JOH 11:37 But some among dem sey, “Dis man wey make blind man si, e nor fit do make Lazarus nor die?”
JOH 11:38 Jesus sorry for dem again, den e waka go di grave. (Dis grave na big whole inside rock wey dem take big stone kover).
JOH 11:39 Jesus kon sey, “Make una remove di stone.” Marta wey bi Lazarus sista kon sey, “Oga God, by dis time e go don dey smell, bikos e don rish for days wey dem beri am.”
JOH 11:40 Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ”
JOH 11:41 So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.
JOH 11:42 I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
JOH 11:43 Wen e don tok dis finish, e kon shaut, “Lazarus, kom out!”
JOH 11:44 Den Lazarus kom out, but di klot wey dem take beri am still kover en body. So, Jesus tell dem, “Make una luz di klot komot for en body, make e dey go.”
JOH 11:45 Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus, wen dem si wetin happen.
JOH 11:46 But some among dem go meet di Farisee pipol kon tell dem wetin Jesus do.
JOH 11:47 Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?
JOH 11:48 If wi let am kontinue like dis, evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.”
JOH 11:49 Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen.
JOH 11:50 Una nor know sey e betta make one man die for evribody, dan sey make evribody for dis kountry die?”
JOH 11:51 (Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok,
JOH 11:52 and nor bi for only di Jew pipol, but make all God shidren, wey dey di world for gada togeda.)
JOH 11:53 So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.
JOH 11:54 Bikos of dis, Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before, but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim, wey near wildaness.
JOH 11:55 Wen Passova Feast don near, many pipol for di kountry go Jerusalem, kon dey make demsef klean for di feast, as dia tradishon tok.
JOH 11:56 Dem bigin dey look for Jesus kon dey ask each oda inside di temple yard, “Wetin yu tink, e go kom for di feast?” Abi yu nor tink so?
JOH 11:57 (By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).
JOH 12:1 Six days before Passova Feast rish, Jesus go Betany, where Lazarus, di pesin wey e wake-up from deat, dey stay.
JOH 12:2 So dem kon do party for Jesus dat evening. Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus.
JOH 12:3 Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).
JOH 12:4 But Judas Iskariot, one among Jesus disciple (di pesin wey go sell am give en enemies) kon sey,
JOH 12:5 “Why wi nor sell dis perfume for three hundred koins (money wey pass wetin workers go get for one year) kon give di money to poor pipol?”
JOH 12:6 (Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)
JOH 12:7 Den Jesus ansa, “Make yu nor trobol di woman, e do dis tin dey wait di day wen dem go beri mi.
JOH 12:8 Poor pipol go always dey with una, but I nor go dey with una all di time.”
JOH 12:9 For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up.
JOH 12:10 Di priest oga dem kon plan to kill Lazarus too,
JOH 12:11 bikos naim make plenty Jew pipol for Jerusalem, bilive Jesus.
JOH 12:12 Wen day break, plenty pipol wey kom di Feast kon hear sey Jesus dey kom Jerusalem.
JOH 12:13 Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, “Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us. Make God bless Israel king!”
JOH 12:14 Jesus si one small donkey and e kon sidan put, just as God word sey,
JOH 12:15 “Pipol wey dey Zion, make una nor fear; make una si una king sidan on-top donkey dey kom!”
JOH 12:16 (En disciples nor undastand dis tins wey dey happen, until wen Jesus don wake-up from grave, naim dem kon remember wetin God word sey go happen.)
JOH 12:17 So di pipol wey dey with am wen e wake Lazarus from grave kon tell odas about am.
JOH 12:18 And dem gada go meet Jesus, bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave.
JOH 12:19 Den di Farisee pipol kon tell each oda, “Una dey si sey wetin wi dey do so nor get head! Si o-o, evribody don bigin follow am.”
JOH 12:20 Some Greek pipol go woship God for di feast for Jerusalem.
JOH 12:21 Dem meet Filip wey kom from Betsaida for Galilee kon tell am, “Oga God, wi go like to si Jesus.”
JOH 12:22 Filip tell Andru, den dem kon go tell Jesus.
JOH 12:23 Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin.
JOH 12:24 I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed.
JOH 12:25 Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end.
JOH 12:26 Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.
JOH 12:27 “My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.
JOH 12:28 Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”
JOH 12:29 Wen di pipol wey dey di place hear di vois, some kon sey, “Di vois sound like tonda”, but odas sey, “Na angel dey tok to am.”
JOH 12:30 Jesus kon sey, “Dis vois nor tok bikos of mi, but na bikos of una.
JOH 12:31 Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.
JOH 12:32 But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”
JOH 12:33 (E tok like dis, make pipol for know di way e go take die).
JOH 12:34 Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
JOH 12:35 Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.
JOH 12:36 As una get di lite naw, make una bilive am, so dat una go bi lite shidren.” Wen Jesus don tok dis tin finish, e kon komot der go hide.
JOH 12:37 Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.
JOH 12:38 Dis make wetin Profet Isaya tok happen, wen e sey, “Oga God, wish pipol don bilive wetin wi tok and who God don show en pawa?”
JOH 12:39 As di pipol nor fit bilive, naim make Profet Isaya tok anoda word sey,
JOH 12:40 “God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”
JOH 12:41 Profet Isaya tok dis tins, bikos e si how God honor and tok about Christ.
JOH 12:42 Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus, but bikos of di Farisee pipol, doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ, so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog.
JOH 12:43 Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.
JOH 12:44 Jesus kon shaut sey, “Di pesin wey bilive mi, nor bi mi e bilive, but na my Papa wey send mi.
JOH 12:45 And di pesin wey si mi, don si God wey send mi.
JOH 12:46 I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.
JOH 12:47 “Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go judge am, bikos I nor kom judge di world, but I kom save pipol for di world.
JOH 12:48 Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.
JOH 12:49 Bikos nor bi my pawa I take dey tok, but na my Papa wey send mi dey tell mi wetin I dey tok.
JOH 12:50 I know sey anytin wey God kommand, dey give life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi.”
JOH 13:1 Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
JOH 13:2 Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy.
JOH 13:3 Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,
JOH 13:4 e kon stand up for where dem dey chop, remove en big koat kon tie towel for en waist.
JOH 13:5 E pour wota for basin, bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist.
JOH 13:6 Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?”
JOH 13:7 Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.”
JOH 13:8 Pita tell am, “I nor go gri make yu wosh my leg!” Den Jesus ansa, “If I nor wosh yor leg, mi and yu nor go get anytin togeda again.”
JOH 13:9 So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!”
JOH 13:10 Jesus ansa, “Di pesin wey don baf, only nid to wosh en leg, bikos e don dey klean. Una dey klean, but nor bi all of una.”
JOH 13:11 (Bikos Jesus know di pesin wey go sell am, naim make am sey, “Nor bi all of una dey klean.”)
JOH 13:12 So wen Jesus don wosh dia leg finish, e kon wear en big koat back. Den e go sidan for di tabol kon ask dem, “Una undastand wetin I do for una so?
JOH 13:13 Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi.
JOH 13:14 So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too.
JOH 13:15 I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una.
JOH 13:16 Make I tell una true word, savant nor dey big pass en oga, just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am.
JOH 13:17 Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.
JOH 13:18 “Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
JOH 13:19 “I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ.
JOH 13:20 I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.”
JOH 13:21 Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”
JOH 13:22 Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?”
JOH 13:23 John, di disciple wey Jesus love well-well, sidan for en rite hand wen dem dey chop.
JOH 13:24 So, Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about.
JOH 13:25 Den John bend en head near Jesus chest kon ask am, “Oga God, who yu dey tok about?”
JOH 13:26 Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin.
JOH 13:27 Afta Judas take di bread, devil enter en mind. Jesus kon tell am, “Di tin wey yu won do, make yu go do am kwik-kwik.”
JOH 13:28 (No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat.
JOH 13:29 Some of dem tink sey, since na Judas dey keep di money, Jesus tell am sey make e go buy wetin dem go use for di feast or make e give poor pipol money).
JOH 13:30 Wen Judas don take di bread, e hurry komot for di place. (By dis time, day don dark.)
JOH 13:31 Wen e don komot, Jesus kon sey, “Naw, di time don rish wen God go honor en pikin and en pikin go honor am too.
JOH 13:32 Wen di pikin don honor God, God go honor am too.
JOH 13:33 “My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
JOH 13:34 “I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una,
JOH 13:35 so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.”
JOH 13:36 Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?” Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.”
JOH 13:37 Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!”
JOH 13:38 Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”
JOH 14:1 “Make una nor let anytin worry una mind. Since una bilive God, make una still bilive mi.
JOH 14:2 Many rooms dey for my Papa house and I dey go prepare place for una to stay, if nor bi so, I for tell una.
JOH 14:3 Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey.
JOH 14:4 And una go know di place wey I dey go and how una go take rish der.”
JOH 14:5 Tomas ask am, “Oga God, wi nor know where yu dey go, how wi go take know road?”
JOH 14:6 Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.
JOH 14:7 But since una don know mi, una go know my Papa too. Naw wey una don know am, una don si am.”
JOH 14:8 Filip kon sey, “Oga God, show us yor Papa and wi go dey okay.”
JOH 14:9 Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’
JOH 14:10 Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.
JOH 14:11 Make una bilive sey I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi, but if una nor fit bilive mi, make una bilive bikos of di mirakles wey I dey do.
JOH 14:12 I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
JOH 14:13 And anytin wey una use my name ask, I go do am, so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin.
JOH 14:14 If una ask anytin with my name, I go do am for una.
JOH 14:15 “If una love mi, una go do wetin I tok.
JOH 14:16 Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever.
JOH 14:17 Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
JOH 14:18 I nor go leave una like pikin wey nor get papa and mama, bikos I go kom meet una again.
JOH 14:19 Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too.
JOH 14:20 Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.
JOH 14:21 Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”
JOH 14:22 Judas (dis nor bi Judas Iskariot) kon sey, “Oga God, why yu won show yorsef give us and yu nor won show oda pipol for di world?”
JOH 14:23 Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.
JOH 14:24 Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.
JOH 14:25 “I don dey tell una all dis tins since I dey with una.
JOH 14:26 But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.
JOH 14:27 Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.
JOH 14:28 “Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.
JOH 14:29 I don tell una naw before e happen, so dat wen e happen, una go bilive mi.
JOH 14:30 I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body.
JOH 14:31 Since I dey do wetin my Papa tell mi, di world go know sey I love my Papa. “So make una get up make wi dey go.
JOH 15:1 “Na mi bi di korrect vine and na my Papa bi di gardina.
JOH 15:2 E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
JOH 15:3 Una dey klean already, bikos of di word wey I tell una.
JOH 15:4 Make una dey inside mi, so dat I go dey inside una too. As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine, na so una nor go fit bear fruit, unless una dey inside mi.
JOH 15:5 “Na mi bi di vine and na una bi di branches dem. Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am, go bear plenty fruit, bikos without mi, una nor go fit do anytin.
JOH 15:6 Anybody wey nor stay inside mi, go dry and pipol go gada en branches dem, trow and burn dem inside fire.
JOH 15:7 If una stay inside mi and my word dey inside una, anytin wey una ask, I go do am for una.
JOH 15:8 My Papa go get big honor if una bear plenty fruit, wey go show sey una bi my disciples.
JOH 15:9 “As my Papa love mi, na so I love una too, so make una live di kind life wey go let mi fit love una more-more.
JOH 15:10 If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.
JOH 15:11 I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.
JOH 15:12 Dis na di kommand wey I give una sey, ‘Make una love each oda di way I love una.’
JOH 15:13 E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend.
JOH 15:14 Una go bi my friend if una do wetin I tok.
JOH 15:15 I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
JOH 15:16 Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
JOH 15:17 Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”
JOH 15:18 “If pipol for dis world hate una, make una remember sey na mi dem first hate.
JOH 15:19 If una bi friend with di pipol for dis world, dem go love una as dia own pipol. But una nor bi dia friend, bikos I don choose una from di world, naim make dem nor like una.
JOH 15:20 Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.
JOH 15:21 Since dem nor know di Pesin wey send mi kom, dem go do all dis tins to una bikos of my name.
JOH 15:22 If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilty for dia sin. But naw, dem nor get any eskuse for dia sin.
JOH 15:23 Di pesin wey hate mi, hate my Papa too.
JOH 15:24 If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
JOH 15:25 All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’
JOH 15:26 “But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok about mi.
JOH 15:27 And unasef go tok about mi, bikos una dey with mi from di biginnin.”
JOH 16:1 “I dey tell una all dis tins, so dat nobody go fit deceive una.
JOH 16:2 Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.
JOH 16:3 Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa.
JOH 16:4 But I tell una all dis tins, so dat wen di time rish, una go remember sey I tell una about dem before. I just dey tell una all dis tins, bikos I dey with una since.
JOH 16:5 “Naw, I dey go meet di Pesin wey send mi kom, but una dey ask mi, ‘Where yu dey go?’
JOH 16:6 But una nor happy as I dey tell una all dis tins.
JOH 16:7 I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una.
JOH 16:8 Wen e kom, e go show pipol for dis world wetin sin, God raitiousness and God judgement, bi.
JOH 16:9 Di Spirit go show dem sey dem dey wrong about sin, bikos dem nor bilive mi.
JOH 16:10 Dem dey wrong about God raitiousness, bikos I dey go meet my Papa and dem nor go si mi again.
JOH 16:11 And dem dey wrong about judgement, bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.
JOH 16:12 “I get plenty tins wey I won tell una, but una nor go fit bear dem naw.
JOH 16:13 But wen God Spirit kom, e go show una di trut. E nor go tok wetin dey en mind, but e go tok wetin e hear from God and wetin go happen afta I don go.
JOH 16:14 E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi.
JOH 16:15 Evritin wey my Papa get, na my own, naim make mi tok sey di Spirit go tell una wetin e dey hear from mi.
JOH 16:16 “Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi.”
JOH 16:17 Den some among di disciple kon dey ask each oda, “Wetin e mean wen e sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi bikos I dey go meet my Papa?’ ”
JOH 16:18 Some still sey, “Wetin e get for mind wen e sey, ‘Time go soon kom?’ Wi nor undastand wetin e dey tok.”
JOH 16:19 Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’
JOH 16:20 I tell una true word, una go kry and mourn, but di world go dey happy; una go dey sad well-well, but una sadnes go turn to happiness.
JOH 16:21 Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.
JOH 16:22 Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.
JOH 16:23 By dat time, una nor go ask mi anytin again. I tell una true word sey, anytin wey una ask my Papa with my name, E go give una.
JOH 16:24 Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.
JOH 16:25 “Since I dey use parabol tok to una; but di time dey kom wen I nor go use parabol again, but I go tell una about my Papa for di way wey una go undastand.
JOH 16:26 By dat time, una go fit ask anytin with my name and God go do am for una.
JOH 16:27 My Papa love una, bikos una love mi and bilive sey na-im send mi.
JOH 16:28 Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”
JOH 16:29 En disciples kon sey, “Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol.
JOH 16:30 Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”
JOH 16:31 Jesus kon tell dem, “So una don bilive naw?
JOH 16:32 Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
JOH 16:33 “I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
JOH 17:1 Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.
JOH 17:2 Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.
JOH 17:3 Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’
JOH 17:4 I don give yu glory for dis world and I don finish di work wey yu send mi.
JOH 17:5 And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.
JOH 17:6 I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.
JOH 17:7 Naw, dem don know sey evritin wey yu give mi kom from yu,
JOH 17:8 bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.
JOH 17:9 I dey pray for di pipol wey yu give mi, bikos dem bi yor own, but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world.
JOH 17:10 Evritin wey I get, na yor own and evritin wey yu get, na my own and dem don honor mi.
JOH 17:11 I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.
JOH 17:12 Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.
JOH 17:13 Since I dey kom meet yu, I dey tok all dis tins for di world, so dat dia joy go full well-well.
JOH 17:14 I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world.
JOH 17:15 I nor sey make yu remove dem from di world, but make yu protet dem from di devil.
JOH 17:16 Dem nor bilong to di world, just as misef nor bilong to di world.
JOH 17:17 Make yu protet dem with di trut, bikos na yor word bi di trut.
JOH 17:18 Just as yu send mi kom inside dis world, na so too I send dem go inside di world.
JOH 17:19 I don separate mysef from di world for dia sake, so dat dem go fit separate diasef from di world too.
JOH 17:20 I nor dey pray for dem alone, but I also dey pray for oda pipol wey go bilive mi thru di word wey dem go tok about mi.
JOH 17:21 Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.
JOH 17:22 I don give dem di honor wey yu give mi, so dat dem go bi one just as wi bi one:
JOH 17:23 I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
JOH 17:24 Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
JOH 17:25 Holy Papa, even if di pipol for di world nor know yu, I know yu and dis ones know sey na yu send mi.
JOH 17:26 I don help dem know yor name and I go dey try to make oda pipol know am too, so dat di love wey yu get for mi, go dey with dem, as I dey with dem.”
JOH 18:1 Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.
JOH 18:2 (Judas, wey sell Jesus, know di place, bikos Jesus don go der with en disciples many times).
JOH 18:3 So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.
JOH 18:4 Bikos Jesus know evritin wey go happen to am, e kon ask dem, “Who una dey find?”
JOH 18:5 Dem ansa am, “Na Jesus wey kom from Nazaret.” E kon tell dem, “Na mi bi di pesin.” (Judas wey sell am, stand der with dem).
JOH 18:6 So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
JOH 18:7 Den Jesus ask dem again, “Who una sey una dey find?” Dem ansa, “Na Jesus wey kom from Nazaret.”
JOH 18:8 Jesus kon sey, “I don tell una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey find, make una allow dis men go.”
JOH 18:9 (E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true, “I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)
JOH 18:10 Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).
JOH 18:11 Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”
JOH 18:12 Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope.
JOH 18:13 Dem take am go meet Annas, Kaiafas fada-in-law, wey bi di High Priest for dat year.
JOH 18:14 (Dis na di Kaiafas wey advise di Jew oga dem sey, “E good make one man die for evribody”).
JOH 18:15 Simon Pita with anoda disciple kon follow dem as dem dey take Jesus go meet Annas. (Di oda disciples know di High Priest well-well, so e follow Jesus enter inside di High Priest kompond).
JOH 18:16 But Simon Pita stand outside di kompond near di door. Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.
JOH 18:17 Di girl wey dey di gate kon ask Pita, “Yu nor bi one of dis man disciple?” At wons, Pita ansa, “I nor bi one of dem.”
JOH 18:18 For dis time, all di savant and guards gada round shako fire wey dem make to warm demsef, bikos kold strong well-well. Pita follow dem stand der dey warm ensef too.
JOH 18:19 As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.
JOH 18:20 Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret.
JOH 18:21 Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”
JOH 18:22 Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
JOH 18:23 Den Jesus sey, “If wetin I tok nor korrect, make yu tell mi, but if e korrect, why yu slap mi?”
JOH 18:24 Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.
JOH 18:25 As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?” Pita deny sey, “I nor dey among dem.”
JOH 18:26 One High Priest savant, wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey, “I nor si yu with am for inside di farm?”
JOH 18:27 Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”
JOH 18:28 Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.
JOH 18:29 So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem, “Wetin una sey dis man do?”
JOH 18:30 Dem ansa, “If to sey dis man nor bi criminal, wi nor for bring am kom meet yu.”
JOH 18:31 Den Pilate tell dem, “Make una go judge am as una law tok.” Di Jew oga dem kon sey, “Awa law nor give us pawa to kill anybody.”
JOH 18:32 (Dis tin happen to show sey wetin Jesus tok about how e go die, na true).
JOH 18:33 So Pilate go inside en house for di palis, kon koll Jesus ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
JOH 18:34 Jesus ansa am, “Na from yor mind yu ask dis kweshon, abi pipol don tell yu about mi?”
JOH 18:35 Pilate kon sey, “Yu know sey I nor bi Jew, abi? Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi. Wetin yu do sef?”
JOH 18:36 Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
JOH 18:37 Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”
JOH 18:38 Pilate still ask am, “Wetin bi di trut?” Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem, “I nor si any bad tin wey dis man do o-o.
JOH 18:39 But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova, una wont make I free Jesus, wey bi di Jew king?”
JOH 18:40 Den, dem kon dey shaut, “Wi nor wont dat man, na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”
JOH 19:1 Den Pilate kon sey make dem flog Jesus with koboko.
JOH 19:2 Den di sojas go kut tree branches wey get shuku-shuku make crown put for en head and dem kon wear am klot wey dear well-well.
JOH 19:3 Dem kon dey laf am, dey take am make yeye, dey sey, “Make una kon si di Jew pipol king.” Dem slap am for face many times.
JOH 19:4 Pilate kom out again kon tell di Jew oga dem sey, “I won bring am kom out for una, to let una know sey I nor si anytin bad wey e do.”
JOH 19:5 So Jesus kom outside, with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, “Na di man bi dis!”
JOH 19:6 Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!” Den Pilate sey, “Make only una go nail am. But as for mi, I nor si any bad tin wey e do.”
JOH 19:7 Di Jew oga dem ansa, “Wi get law and di law sey, e suppose to die, bikos e sey en na God Pikin.”
JOH 19:8 Wen Pilate hear wetin dem tok, fear kon katch am well-well.
JOH 19:9 So e enter di house back kon ask Jesus, “Na where yu from kom sef?” But Jesus nor ansa am.
JOH 19:10 So Pilate kon sey, “Yu nor won tok to mi? Yu nor know sey I get pawa to free or kill yu?”
JOH 19:11 Jesus ansa, “Yu nor get pawa at-all for my life, escept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom meet yu, na dia sin big pass yor own.”
JOH 19:12 From dat time, Pilate kon bigin find way to free Jesus, but di Jew oga dem kon dey shaut, “If yu free dis man, yu nor bi Caesar friend. Anybody wey sey en bi king, na Caesar enemy e bi.”
JOH 19:13 Wen Pilate hear wetin dem tok, e bring Jesus kom out kon sidan for di chair for where e dey judge kase, (dem dey koll di chair, “Di Stone Pavement”, but na Gabbata dem dey koll am for Aramaik language.)
JOH 19:14 (Dat time na aftanoon for di day wen dem dey prepare for Passova Feast). So, Pilate kon tell di Jew oga dem, “Make una look, na una king bi dis!”
JOH 19:15 Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!” Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?” Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”
JOH 19:16 So Pilate kon gi-am to dem make dem go kill-am. Den dem kon take Jesus komot for der.
JOH 19:17 As Jesus karry en cross dey go, e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.)
JOH 19:18 For der, dem kon nail Jesus for cross. Dem still nail two oda pipol for cross, one for en rite and di oda for en left.
JOH 19:19 Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jesus cross, wey sey, “dis na Jesus wey kom from Nazaret, wey bi di Jew pipol king.”
JOH 19:20 Since di place where dem kill Jesus near town, many of di Jew pipol wey dey for Jerusalem kom read di sign-board, bikos dem rite am for three language wey bi Aramaik, Latin and Greek.
JOH 19:21 Den di shief priests kon tell Pilate, “Make yu nor rite sey, dis na Jew pipol king, but rite sey, dis man sey, ‘I bi Jew pipol king.’ ”
JOH 19:22 But Pilate ansa dem, “Wetin I don rite finish, na so e go bi.”
JOH 19:23 Wen di sojas don nail Jesus for cross, dem tear en klot and dem for kon divide am. But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am, since dem weave-am from top go rish bottom).
JOH 19:24 So di sojas tell each oda sey, “Make wi nor tear am, but make wi gambol to si who go take am.” Dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem go divide my klot, afta dem don gambol for am.” Dis na wetin di sojas kon do.
JOH 19:25 By dis time, di only pipol wey stand near di cross where dem nail Jesus, na-im mama; en aunty, Mary wey bi Klopas wife and Mary Magdalin.
JOH 19:26 So wen Jesus si en mama and John, di disciple wey e love well-well stand for der, e kon tell en mama, “Mama, look, dis na yor pikin.”
JOH 19:27 Den e tell di disciple, “Make yu look, dis na yor mama.” From dat time, di disciple kon take Jesus mama go en own house.
JOH 19:28 Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).
JOH 19:29 Di sojas soak sponge inside wine wey betta, wey dey one kontaina for der kon put am for di branches of one plant wey dem dey koll hyssop kon stresh am put for Jesus mout.
JOH 19:30 Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.
JOH 19:31 Dis tin happen for di day wen dem dey prepare for di Passova Feast and bikos dem nor wont make di dead body dem stay for cross for Sabat Day, (bikos dat Sabat Day na special one for dem), di Jew oga dem kon tell Pilate make dem break dia leg, to make sure sey dem don die, so dat dem go fit bring dia dead body kom down.
JOH 19:32 So di sojas break di oda two pipol leg wey dem kill with Jesus.
JOH 19:33 But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg.
JOH 19:34 But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out.
JOH 19:35 All dis story na true, (bikos na di pesin wey si dem happen, naim tok about dem and wetin e tok na true), so dat una go fit bilive.
JOH 19:36 All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.”
JOH 19:37 And God word still sey, “Dem go stand dey sopraiz as dem dey look di pesin wey dem shuk en body.”
JOH 19:38 Afta dis time, Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jesus sekret disciple, (bikos e dey fear di oda Jew oga dem), kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der. Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.
JOH 19:39 Nikodimos, di man wey hide go si Jesus for nite, kon follow Josef. E karry perfume wey heavy rish seventy-five pounds, wey dem take myrrh and aloe spice make.
JOH 19:40 Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri.
JOH 19:41 One gardin dey near di place where dem kill Jesus and one new grave wey dem neva beri anybody put before, dey inside di gardin.
JOH 19:42 Since dat day na di day wey Jew pipol dey prepare for di Passova Feast and bikos di new grave dey near der, dem kon beri Jesus inside di grave.
JOH 20:1 For di first day for di week, wen day neva break well, Mary Magdalin kon go where di grave dey. E si sey dem don remove di stone wey dem take kover di grave mout.
JOH 20:2 Den e run go meet Simon Pita and John kon tell dem, “Somebody don karry Jesus body komot from di grave and wi nor know where dem put am.”
JOH 20:3 So Pita and John kon go where di grave dey.
JOH 20:4 Di two of dem kon dey run togeda, but John run pass Pita kon first am rish di grave.
JOH 20:5 E nor enter inside di grave, but e bend down kon si di linen klot wey dem take wrap Jesus body for groun inside di grave.
JOH 20:6 Wen Simon Pita rish der, e enter inside di grave kon si di linen klot for groun too.
JOH 20:7 But di small klot wey dey for Jesus head nor dey for di same place where di oda klot dey, e dey on en own for one korna.
JOH 20:8 Den John kon enter inside and wetin e si kon make am bilive.
JOH 20:9 (Bikos dem undastand God word wey sey, Jesus go wake-up afta e die).
JOH 20:10 So di two disciple kon go back to dia house.
JOH 20:11 But Mary stand for outside di grave dey kry. As e still dey kry, e kon bend down look inside di grave.
JOH 20:12 Den e si two angel wey wear white klot sidan for where dem put Jesus body. One dey for where di head dey and di oda dey for where di leg dey.
JOH 20:13 Dem kon ask am, “Woman, why yu dey kry?” Mary ansa, “Dem don karry my oga komot and I nor know where dem karry am go.”
JOH 20:14 Afta e tok finish, e turn round kon si Jesus stand for der, but e nor know sey na Jesus bi dat.
JOH 20:15 Jesus tell am, “Woman, why yu dey kry? Na who yu dey find?” Bikos Mary tink sey naim bi di gardina, e kon sey, “Oga God, if na yu karry am komot, make yu tell mi where yu karry am go, so dat I go-go karry am.”
JOH 20:16 Den Jesus koll am, “Mary.” So, Mary turn round face am kon koll am for Hibru language, “Raboni!” (wey mean Tisha).
JOH 20:17 Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
JOH 20:18 Den Mary Magdalin go meet di disciples for where dem dey kon tell dem, “I don si di Oga God!” Den e tell dem wetin Jesus tell am.
JOH 20:19 Dat evening, for di first day for di week, en disciples kon gada togeda. Dem lock di door for di house wey dem dey, bikos dem dey fear di Jew oga dem. Jesus stand among dem kon sey, “Make peace dey with una.”
JOH 20:20 Wen e don tok finish, e show dem en hand and di korna for en belle wey dem shuk with spear. Den di disciples kon happy well-well, wen dem si Jesus.
JOH 20:21 Den Jesus tell dem again, “Make peace dey with una. As my Papa send mi, na so I send una too.”
JOH 20:22 Wen e tok finish, e breath for dia body kon sey, “Make una receive di Holy Spirit.
JOH 20:23 If una forgive anybody en sin, God go forgi-am, but if una nor forgive anybody en sin, God nor go forgi-am.”
JOH 20:24 For dis time, Tomas (wey bi twins), one among di twelf disciples, nor dey der wen Jesus show ensef to dem.
JOH 20:25 Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.” But e ansa dem, “Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle, I nor go ever bilive una.”
JOH 20:26 Afta eight days, wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time, even doh sey dem lock all di doors, Jesus show ensef kon stand among dem sey, “Make peace dey with una.”
JOH 20:27 Den e tell Tomas, “Put yor finger for my hand, make yu tosh am. Stresh yor hand put inside di korna for my belle. Make yu nor dey doubt again, but make yu bilive.”
JOH 20:28 Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”
JOH 20:29 Den Jesus tell am, “So yu bilive naw, bikos yu don si mi? God go bless pipol wey neva take eye si mi, but dem bilive mi.”
JOH 20:30 Jesus do many mirakles wen e dey with en disciples wey dem nor rite for dis book.
JOH 20:31 But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.
JOH 21:1 Afta dis, Jesus show ensef again to en disciples near Tiberias Sea. Dis na how e do am.
JOH 21:2 Simon Pita and Tomas (wey bi twins), with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee), with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples, kon gada togeda.
JOH 21:3 Simon Pita kon tell dem, “I dey go katch fish.” Dem sey, “Wi too go follow yu go.” Den dem komot go enter one kenu. But dat nite dem nor katch any fish.
JOH 21:4 Wen day break, Jesus stand for di wotaside, but di disciples nor know sey naim dey der.
JOH 21:5 Jesus kon ask dem, “My shidren, una katch any fish?” Dem ansa, “No o-o.”
JOH 21:6 E kon tell dem, “Make una trow una net go di rite side for di kenu and una go katch some fish.” Wen dem don trow dia net inside di river, dem nor fit draw am komot from di wota, bikos di fish wey dem katch, plenty well-well.
JOH 21:7 Den, John, di disciple wey Jesus love kon tell Pita, “Dis man na Jesus o-o.” Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus, e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under), den e jump inside di river.
JOH 21:8 By dis time, di oda disciples dey inside di kenu dey pul di net with di plenty fish go rish groun for di wotaside (bikos where dem dey, na about one hundred yard from di wotaside).
JOH 21:9 Wen dem don kom down from di kenu, dem kon si shako fire with fish and some bread on-top am.
JOH 21:10 Jesus tell dem, “Make una bring some for di fish wey una katch kom.”
JOH 21:11 Den Simon Pita enter di kenu kon pul di net kom groun. Di net katch plenty big-big fish wey rish one hundred and fifty-three and di net nor tear.
JOH 21:12 Jesus tell dem, “Make una kom chop.” But dem nor fit ask am, “Who yu bi”, bikos dem bilive sey na Jesus e bi.
JOH 21:13 Den Jesus kon give dem bread and fish.
JOH 21:14 Dis make am di third time wen Jesus show ensef to en disciples, afta e don raiz-up from grave.
JOH 21:15 Wen dem don chop finish, Jesus ask Simon Pita, “Simon, John pikin, yu love mi pass all dis tins?” E ansa, “Yes, Oga God! Yu know sey I love yu.” Jesus kon tell am, “Make yu feed my sheep.”
JOH 21:16 Jesus ask am again, “Simon, John pikin, yu really tink sey yu love mi?” Pita ansa, “Yes, oga! Yu know sey I love yu.” Jesus kon tell am, “Make yu kare for my sheep.”
JOH 21:17 Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.
JOH 21:18 I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”
JOH 21:19 (Jesus tok dis to show how Pita go die, so dat God go get honor). Afta Jesus tok finish, e kon tell Pita, “Make yu follow mi.”
JOH 21:20 Wen Pita turn round, e kon si John, (di disciple wey Jesus love well-well), dey follow dem. (Dis na di disciple wey bend en head near Jesus chest wen dem dey chop kon ask am, “Oga God, who bi di pesin wey go sell yu give yor enemy?”)
JOH 21:21 Wen Pita si am, e kon ask Jesus, “Oga God, wot about dis man?”
JOH 21:22 Jesus ansa am, “Make yu mind yor own business. If I wont sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside? Make yu yorsef follow mi.”
JOH 21:23 Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey, di disciple nor go die. But Jesus nor really tell Pita sey di oda disciple nor go die, but e sey, “If I won sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside?”
JOH 21:24 Na dis bi di disciple wey bear witness about all dis tins and wey rite dem and wi know sey wetin e rite, na true.
JOH 21:25 Jesus do many oda tins wey dem nor rite down. If to sey dem rite all of dem, di world nor go get space wey go kontain all di book, where dem rite dem put.
ACT 1:1 My friend Teofilus, for di book wey I first rite give yu, I tok about all di tins wey Jesus Christ start to dey do and tish,
ACT 1:2 until di day wen God kon karry am go heaven, afta e give orda to di apostles, wey e choose with di Holy Spirit.
ACT 1:3 Na di same apostles e show ensef many time sey, e still dey alive afta di sofa wey e sofa. Dem si am for forty days and e tell dem about God kingdom.
ACT 1:4 Den wen e follow dem sidan dey tok, e kon kommand dem sey, “Make una nor leave Jerusalem, but make una wait for di tin wey my Papa promise wey I don tell una before.
ACT 1:5 John dey baptize with wota, but e nor go tey wen God go baptize una with en Holy Spirit (wey go kontrol una life forever).”
ACT 1:6 So wen dem gada, dem kon start to ask Jesus Christ, “Oga God! Na naw yu go start to rule Israel?”
ACT 1:7 Jesus ansa dem, “Di time wey God plan nor koncern una,
ACT 1:8 but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
ACT 1:9 So afta e don tok with dem, God kon karry am up until kloud kover am and dem nor fit si am again.
ACT 1:10 As dem still dey look up as e dey go, two men wey wear white klot stand near dem
ACT 1:11 kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”
ACT 1:12 So dem go back to Jerusalem from Mount Olives (wey dey near Jerusalem and di place wey dem waka so, far pass how di law dey allow pipol waka for Sabat Day).
ACT 1:13 Wen dem enter Jerusalem, dem kon go di room for upstair where dem dey stay. Pita and John; James and Andru; Filip and Tomas; Bartolomew and Matiu; James wey bi Afaeus pikin, Simon wey dem dey koll Zealot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.
ACT 1:14 Dem kon dey pray togeda evriday with one mind, with all di wimen, plus Mary, Jesus Christ mama and en brodas.
ACT 1:15 Di pipol wey dey pray, plenty rish one hundred and twenty. So Pita stand up for di pipol front kon sey,
ACT 1:16 “My brodas, di word wey di Holy Spirit use David tok about Judas, wey show road to di pipol wey arrest Jesus Christ, must happen,
ACT 1:17 bikos e dey awa group before and e dey follow us do di work.”
ACT 1:18 (Dis Judas buy one land with di money wey e kollect for di wiked tin wey e do and na der e hang ensef till en belle burst and all en intestine kon skata kom out,
ACT 1:19 sotey all di pipol for Jerusalem hear di story and naim make dem dey koll di place for dia language, “Akeldama”, wey mean, “Blood Land”).
ACT 1:20 “For Psalms book, God word sey, ‘Make en house empty, make nobody stay der again and make anoda pesin take en place.’
ACT 1:21 So, make one pesin from di men wey dey follow us since di time wey Oga God Jesus Christ dey with us,
ACT 1:22 from wen dem baptize am, until e go up leave us; make e kon join us tell pipol di trut sey, Jesus Christ don raiz-up from grave.”
ACT 1:23 So dem choose two men, one na Josef wey dem dey koll Barsabas (but some pipol dey koll am Justus) and di oda one, na Matias.
ACT 1:24 Den dem kon pray, “Oga God Jesus Christ, na yu know wetin dey inside evribody mind. Make yu show us di pesin wey yu wont among dis two pipol,
ACT 1:25 so dat e go take Apostle Judas, wey kill ensef, place.”
ACT 1:26 Naim dem kon vote to choose between di two men and di pesin wey dem choose, na Matias.
ACT 2:1 Wen Pentekost Day rish, di disciples kon gada for one place.
ACT 2:2 At wons, one kind nois wey bi like heavy breeze kom from heaven kon full di whole house where dem sidan.
ACT 2:3 Dem kon si small-small fire wey bi like kandol lite dey fall kom from heaven on-top dia head, one-by-one.
ACT 2:4 Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
ACT 2:5 Dat time, Jew and oda pipol dey stay for Jerusalem.
ACT 2:6 Wen pipol hear di nois, dem sopraiz kon gada, bikos evribody dey hear di disciples dey tok with difren language, wey demsef dey tok for dia kountry.
ACT 2:7 As di pipol dey sopraiz, dem kon dey ask each oda, “All dis pipol wey dey tok so, nor bi Galilee dem from kom?
ACT 2:8 How e bi sey dem dey speak awa difren language?
ACT 2:9 Wi wey kom from Partia, Medes, Elam, Mesopotamia, Judea, Kappadocia for Pontus and all di aria wey dey for Asia,
ACT 2:10 Frigia and Pamfilia, even di pipol from Egypt and di aria for Libya near Sirene, plus all di strenjas wey kom from Rome,
ACT 2:11 weda dem bi Jew or Gentile, wey dey serve God with dem, like pipol from Krete and Arabia, all of us dey hear, as dem dey use awa language praiz God!”
ACT 2:12 All of dem sopraiz and di tin konfuse dem well-well. So dem kon dey ask each oda wetin dis kind tin mean.
ACT 2:13 But some among dem dey laf di pipol wey dey speak di difren language kon dey sey, “Dis pipol don drink well-well!”
ACT 2:14 But Pita stand up with di eleven apostles kon shaut: “Judea pipol and una wey dey Jerusalem, make una put ear down for wetin I won tell una so. Make una know sey
ACT 2:15 dis men neva drink anytin as una tink, bikos na just nine oklok for morning and e too early to drink.
ACT 2:16 But Profet Joel sey:
ACT 2:17 “ ‘Wen di last day don rish, God sey, “I go pour my Spirit inside evribody and all una shidren, both boys and girls go dey profesai, una yong men go dey si vishon and una old men go dey dream plenty dreams.
ACT 2:18 For dat time, I go give my Spirit to all di pipol wey dey serve mi and dem go dey profesai.
ACT 2:19 I go show plenty wonders for heaven and many mirakles for dis world, blood and fire go appear for inside di sky like smoke.
ACT 2:20 Di sun go black and di moon go red like blood, before di big day wen God tok about, go rish.
ACT 2:21 For dat time, evribody wey koll God name, God go save am.” ’
ACT 2:22 “Israel pipol, make una hear wetin I dey tok, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di man wey God choose and wey e send to una, wey God use do many mirakles and oda wonderful signs for una front, as all of una know,
ACT 2:23 na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.
ACT 2:24 But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.
ACT 2:25 Dis na wetin David tok about sey, “ ‘God always dey near mi and bikos e dey for my rite hand, I nor go fear anytin.
ACT 2:26 Bikos of dis, belle sweet mi and my mout kon dey tok betta-betta tins and I kon get hope sey tins go really good for mi,
ACT 2:27 bikos I know sey God nor go allow mi stay for grave or make my body rotin for groun.
ACT 2:28 “True-true, yu don show mi di way wey dey give life and yu go make mi happy well-well wen I dey for where yu dey.” ’
ACT 2:29 “My pipol, Nor bi true sey awa grand-grand papa, David don die since, dem beri am and en grave dey awa land till today?
ACT 2:30 Wi know sey en na profet, bikos God don promise am sey, naim pikin dem go always bi king for Israel.
ACT 2:31 Bikos of dis vishon wey David si, e kon sey, ‘Di Mezaya go get up from grave, bikos God nor go leave am der make en body rotin for groun.’ As all of us know,
ACT 2:32 God don raiz dis Jesus Christ up and evribody si am.
ACT 2:33 Bikos God don promote am make e dey en rite hand and e don receive di Holy Spirit wey en Papa promise and naw, e don pour di Holy Spirit for awa body, as una si am dey happen so.
ACT 2:34 Wi know sey David neva go heaven, but only en tok with en mout sey, “ ‘God tell my oga sey, “Sidan for my rite hand,
ACT 2:35 until I go make all yor enemies serve yu.” ’
ACT 2:36 So Israel pipol, make una know sey, God don turn dis Jesus Christ wey una kill, to bi Oga God and Mezaya.”
ACT 2:37 Wen di pipol hear dis prishin, e trobol dem for mind well-well and dem kon ask Pita and di rest apostles, “Awa brodas, wetin wi go do naw?”
ACT 2:38 Pita ansa dem, “Make una turn from sin kom meet God one-by-one and make dem baptize una with Jesus Christ name, so dat God go forgive una, den una go fit receive di Holy Spirit.
ACT 2:39 Bikos dis promise na for una, all una pikin, pipol wey dey far place and all di pipol wey God go draw near ensef.”
ACT 2:40 As Pita dey tok to di pipol, e kon warn dem, “Make una save una head from di ponishment wey dey kom meet wiked pipol.”
ACT 2:41 So, dem baptize all of dem wey bilive wetin e prish and dem rish 3,000 pipol wey join dem dat day.
ACT 2:42 Dem kon dey use all dia time dey learn wetin di apostles dey tish. Dem dey waka, help, chop and pray togeda.
ACT 2:43 Di apostles do many wonders and mirakles and bikos of dis, pipol kon dey respet and fear God.
ACT 2:44 All di pipol wey bilive, dey share dia propaty with one anoda and stay togeda.
ACT 2:45 Dem dey sell wetin dem get kon use di money dey help each oda.
ACT 2:46 Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness.
ACT 2:47 Dem kon dey praiz God and dey fellowship with one anoda. So God kon dey add more pipol join dem evriday.
ACT 3:1 One day, Pita and John dey go di temple go pray for three oklok for aftanoon.
ACT 3:2 Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple.
ACT 3:3 As di man si Pita and John wen dem won enter di temple, e kon dey beg dem for money,
ACT 3:4 but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!”
ACT 3:5 So di man wey nor fit waka kon look dem well-well, bikos e tink sey dem won gi-am money.
ACT 3:6 Pita kon tell am, “I nor get silva or gold to give yu: but na wetin I get, I go give yu. With Jesus Christ name wey kom from Nazaret, stand up make yu bigin waka!”
ACT 3:7 Pita hold di man for en rite hand kon drag am up and at wons, di man legs kon strong.
ACT 3:8 Di man jump up bigin waka, e follow dem enter di temple dey waka, dey jump up-and-down, dey praiz God.
ACT 3:9 Pipol si am dey waka dey praiz God
ACT 3:10 and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.
ACT 3:11 Di man still dey jump follow Pita and John with happiness and di pipol still dey sopraiz. Den di pipol run go meet Pita and John for di place wey dem dey koll “Solomon Varanda.”
ACT 3:12 Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka?
ACT 3:13 Na Abraham, Isaak, Jakob and awa grand-grand papa God, naim karry en savant Jesus Christ go up, di one wey una rijet kon gi-am to Pilate make e judge am, even wen e won free am.
ACT 3:14 Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una.
ACT 3:15 Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.
ACT 3:16 Dat Jesus Christ name wey wi bilive, naim make dis man wey una dey si and know well-well, strong. Yes! Naim name don heal dis man as una dey si so.
ACT 3:17 So my brodas, I know sey una and una oga dem nor know wetin una do.
ACT 3:18 God don tok before-before thru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don make am happen, thru wetin una do.
ACT 3:19 So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,
ACT 3:20 so dat una go fit get freedom wey God dey give and E go send Jesus Christ, di Mezaya wey E don prepare down, kom meet una.
ACT 3:21 Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets.
ACT 3:22 Even Moses sef tok before sey, Jehovah wey bi una God go send one profet to una, just as E send mi and e go bi una family memba. Una must obey evritin wey e sey make una do.
ACT 3:23 Anybody wey nor obey dat profet, dem go distroy am and dem go remove am from God family.
ACT 3:24 God don tok about all dis tins wey dey happen so, from Profet Samuel time go rish di profets wey kom afta am.
ACT 3:25 All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’
ACT 3:26 So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”
ACT 4:1 As Pita and John still dey tok, di priests, di temple guide oga and di Sadusi pipol waka kon meet dem.
ACT 4:2 Dem dey vex, bikos Pita and John dey tish di pipol sey, na only thru Jesus Christ, pipol go fit wake-up from deat.
ACT 4:3 So dem arrest dem put for prison till di next day, bikos nite don rish.
ACT 4:4 But pipol wey hear wetin dem tok kon bilive Jesus Christ and di pipol wey bilive, rish 5,000.
ACT 4:5 Di next day, all di rulers, eldas and lawyers kon gada go Jerusalem.
ACT 4:6 Annas, wey bi di High Priest dey der with Kaiafas, John, Alexanda and some membas for di High Priest family.
ACT 4:7 Dem drag Pita and John enter dia centre kon bigin ask dem, “Who give una pawa to do dis tins? Na wish pesin name una dey use so?”
ACT 4:8 Pita wey di Holy Spirit dey use well-well kon ansa, “Awa rulers and eldas,
ACT 4:9 na bikos of di good wey wi do for dis pesin wey nor well, naim make una dey kweshon us today sey, ‘How dis man take well?’
ACT 4:10 My pipol and di oga dem for Israel, make una know sey, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di pesin wey una kill and God raiz am from deat, naim name make dis man wey una dey si so, well.
ACT 4:11 Dis Jesus Christ, di good stone wey una trowey, God don make am di main pila wey dey whole di house.
ACT 4:12 And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”
ACT 4:13 Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.
ACT 4:14 As dem si sey di man wey God heal stand der with Pita and John, dem nor fit deny wetin happen.
ACT 4:15 So dem sey make Pita and John komot for where dem dey, den dem bigin ask each oda,
ACT 4:16 “Wetin wi go do about dis pipol? Bikos evribody wey dey for Jerusalem don know sey na big mirakle naim God use dem do so and wi nor go fit deny am.
ACT 4:17 But make di matter nor for kontinue dey spread among di pipol, make wi warn dem make dem nor tok about dis name again.”
ACT 4:18 So dem koll dem go inside kon warn dem make dem nor tok or tish about Jesus Christ name again.
ACT 4:19 But Pita and John ansa, “Make una judge wetin good pass for dis matter; make wi obey una or make wi obey God,
ACT 4:20 bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”
ACT 4:21 Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so.
ACT 4:22 Di man wey receive dis big mirakle, don pass forty years.
ACT 4:23 As dem free dem, Pita and John go meet dia pipol kon tell dem evritin wey di High Priest and di eldas tok.
ACT 4:24 Wen dem hear wetin happen, dem kon pray to God sey, “God wey dey for heaven, yu wey make heaven, eart, di sea and evritin wey dey inside dem.
ACT 4:25 Yor Spirit tok thru yor savant David, awa grand-grand papa sey, “ ‘Wetin dey make pipol wey dey woship juju dey make nois? Wetin make dem dey plan bad-bad tins?
ACT 4:26 All di kings wey dey di world stand and di rulers gada togeda against Jehovah and di pesin wey E choose.’
ACT 4:27 “True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose
ACT 4:28 and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.
ACT 4:29 Papa God, make yu si how dem dey treaten us. Wi wey bi yor savants, make yu give us pawa to take prish yor word and
ACT 4:30 anytime wen wi koll Yor holy pikin Jesus Christ name, make yu heal pipol and do many wonderful mirakles.”
ACT 4:31 Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.
ACT 4:32 All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.
ACT 4:33 With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well.
ACT 4:34 Nobody among dem sofa, bikos di rish pipol among dem wey get land and house, dey sell dia propaty and bring di money wey dem sell
ACT 4:35 kon give di apostles make dem keep am, so dat dem go gi-am to anybody to take buy wetin e wont.
ACT 4:36 So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus,
ACT 4:37 sell one land wey e get kon give di money to di apostle make evribody use.
ACT 5:1 One man wey dem dey koll Ananias with en wife Saffira kon sell dia land.
ACT 5:2 Dem kon gri sey dem go keep some for di money for demsef. So Ananias take di remainin money go give di apostles.
ACT 5:3 But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?
ACT 5:4 Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”
ACT 5:5 Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen.
ACT 5:6 So di yong men wey dey der, take wrapa kover en body kon karry am go beri.
ACT 5:7 Wen three hours don pass, en wife, Saffira waka kom, but e nor know wetin don happen to en husband.
ACT 5:8 Den Pita ask am, “Madam, tell mi di trut. Na dis bi di prize wey una sell di land? Saffira ansa, ‘Yes, na-im.’ ”
ACT 5:9 So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”
ACT 5:10 At wons, di woman fall for groun kon die for Pita front. So wen di yong men enter inside di house kon si sey di woman don die, dem karry am go beri near where dem beri en husband put.
ACT 5:11 Fear katch di pipol for di church and odas wey hear wetin happen.
ACT 5:12 Na dis kind mirakle and wonder God do thru di apostles for di pipol front and dem kon dey meet for Solomon Varanda.
ACT 5:13 Fear nor let anybody wey nor dey among dem go join dem anyhow and e kon make all di pipol dey respet dem well-well.
ACT 5:14 But plenty men and wimen wey bilive Jesus Christ kon join dem,
ACT 5:15 sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem.
ACT 5:16 Dem bring pipol well nor well and doz wey get evil spirit from all di town and village wey near Jerusalem and God heal all of dem.
ACT 5:17 But jealousy kon full di High Priest and di Sadusi pipol mind,
ACT 5:18 so dem kon arrest di apostles put for prison.
ACT 5:19 But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem,
ACT 5:20 “Make una go stand for di temple varanda bigin prish God word wey dey give pipol life.”
ACT 5:21 Afta dem hear dis, dem enter di temple varanda for morning kon start to dey tish di pipol. Den di priest oga dem and di pipol wey dey follow am kon koll di Sanhedrin, wey bi di big kansol for Israel pipol. Dem send pipol go di prison make dem go bring di apostles kom, bikos dem won judge dia kase.
ACT 5:22 But di savant wey dem send go, nor si dem for di prison, so dem go back go ripot sey,
ACT 5:23 “Wi si sey dem lock di prison well and all di sojas stand for di front, but wen wi open di gate, wi look inside, but wi nor si anybody.”
ACT 5:24 So wen di soja oga wey dey di temple and di priest oga dem hear dis tin, dem sopraiz well-well kon dey wonder wetin happen to di apostles.
ACT 5:25 Na dat time one pesin kon tell dem sey, “Si o-o, di men wey una put for prison dey for di temple varanda dey tish pipol!”
ACT 5:26 So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.
ACT 5:27 Wen dem don bring dem inside, dem kon sey make dem stand for di kansol front and di priest oga dem kon dey kweshon dem.
ACT 5:28 E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?”
ACT 5:29 But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being.
ACT 5:30 Na di God wey awa grand-grand papa dem serve raiz-up Jesus Christ wey una hang for tree.
ACT 5:31 But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.
ACT 5:32 All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.”
ACT 5:33 Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.
ACT 5:34 Den one Farisee wey dem dey koll, Gamaliel, wey dey tish di law and wey di pipol dey respet well-well kon stand up tok, “Make una send dis men go outside first.”
ACT 5:35 Den e kon tok to di kansol, “Una Israel oga, make una tink well before una do anytin to dis men.
ACT 5:36 Bikos na so Teudas still kom up before, dey tok sey en na pesin wey dey important and na about four hundred pipol follow am. Wen dem kill-am, all di pipol wey dey follow am skata and evritin kon end.
ACT 5:37 Afta am, Judas wey kom from Galilee kom out wen dem dey do census. E push pipol to join am oppoz wetin dem dey do. Dem still kill-am and all di pipol wey dey follow am skata too.
ACT 5:38 Naim make I sey for dis matter so, make una remove una hand and leave all dis men, bikos if all di tins wey dem dey plan and do, na from dia mind, dem nor go susid,
ACT 5:39 but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”
ACT 5:40 So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again.
ACT 5:41 So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.
ACT 5:42 So evriday for di temple kompond and from house to house, dem kontinue to dey tish and prish di Good News sey, “Na Jesus Christ bi di Mezaya.”
ACT 6:1 As time dey go, wen di disciples don plenty, di Jew pipol wey dey tok with Greek language kon dey kworel with di oda kountry-men wey dey tok Hibru. Dem kon dey komplain sey, “Wen dem dey share food, di Hibru men dey sofa wimen wey dia husband don die.”
ACT 6:2 So di twelf apostles gada evribody kon sey, “E nor good make wi leave God word wey wi dey prish kon put hand for food matter.
ACT 6:3 So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us.
ACT 6:4 So dat wi go fit put awa mind for prayer, as wi dey prish God word.”
ACT 6:5 Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.
ACT 6:6 Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.
ACT 6:7 Na so God word start to spread and di disciples wey dey Jerusalem kon plenty well-well. And many priests kon bilive Jesus Christ.
ACT 6:8 God bless Stefen well-well kon gi-am pawa to take do many wonders and mirakles among di pipol.
ACT 6:9 But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.
ACT 6:10 But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.
ACT 6:11 So, dem kon bribe some men make dem lie sey, “Wi hear wen dis man tok tins wey dey against Moses and God law.”
ACT 6:12 Dem lie for Stefen head, so di pipol, di eldas and di oga dem for di law kon hate am. So dem arrest Stefen kon karry am go di kansol.
ACT 6:13 Dem bring pipol kon lie sey, “E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins about Moses Law and dis Temple.
ACT 6:14 Wi hear wen e dey tok sey Jesus Christ wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Moses give us.”
ACT 6:15 Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.
ACT 7:1 Di priest oga dem kon ask Stefen, “All dis tins wey dem tok about yu so, na true?”
ACT 7:2 Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am
ACT 7:3 kon tell am sey, ‘Make yu leave yor kountry and yor pipol kon go di land wey I go show yu.’
ACT 7:4 So Abraham leave Kaldean kountry kon go stay for Haran. Afta en papa die, God kon tell am make e stay for dis land wey una dey naw.
ACT 7:5 Dat time, God neva gi-am any part for di land and e neva born any pikin, but God promise am sey E go gi-am di land and en and en shidren go stay der forever.
ACT 7:6 God tell am, ‘Di shidren wey yu go born go bi strenja for anoda kountry and di pipol for dat kountry go sofa dem kon use dem as slave for four hundred years.’
ACT 7:7 But God sey, ‘I go ponish di pipol wey go use dem as slave and afta all dis tins, dem go komot for der kon woship mi for dis place.’
ACT 7:8 So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.
ACT 7:9 Jakob shidren wey bi awa grand-grand papa dem, bikos dem dey jealous Josef dia broda, dem kon sell am as slave go Egypt, but God dey with am
ACT 7:10 kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.
ACT 7:11 Honga kon dey for di whole Egypt and Kanaan and awa grand-grand papa dem nor si food chop.
ACT 7:12 So wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon send awa grand-grand papa dem go shek if na true.
ACT 7:13 Wen dem kom di sekond time, Josef show ensef give en brodas and Fero kon know Josef family.
ACT 7:14 Josef send message go give en papa Jakob sey make en and all di pipol wey dey with am kom Egypt and dem bi seventy-five wey go.
ACT 7:15 So Jakob and awa grand-grand papa dem go Egypt and dem die for der.
ACT 7:16 Dia bone dey der till dem karry dem go beri for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shidren.
ACT 7:17 “But as time dey near wen God go fulfil di promise wey e make with Abraham; Israel pipol kon dey many inside Egypt,
ACT 7:18 till anoda Fero wey nor know Josef kon dey rule.
ACT 7:19 E deceive and sofa awa pipol sotey e force dem to leave dia shidren make dem die.
ACT 7:20 Na dat time dem born Moses and God kon like am well-well. Moses stay for en papa house for only three monts
ACT 7:21 and wen dem trowey am for river, Fero dota kon take and train am as en own pikin.
ACT 7:22 So dem tish Moses all di wise tins wey Egypt pipol dey do and e kon get wisdom for how e dey tok and wetin e dey do.
ACT 7:23 But wen forty years don rish, e kon tink am sey e good make e go visit en own Israel pipol.
ACT 7:24 Wen e si one man from Egypt dey opress one Israel pesin, Moses kon defend and kill di Egypt man.
ACT 7:25 E tink sey en own pipol go undastand sey God won use am take save dem, but dem nor undastand.
ACT 7:26 Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’
ACT 7:27 But di man wey dey opress en broda kon sey, ‘Who give yu pawa to rule and judge us?
ACT 7:28 Hope yu nor won kill mi di way yu kill dat Egypt man yestiday?’
ACT 7:29 Wen di man tok like dis, Moses run go Midian, anoda land where e stay as strenja kon born two boys for der.
ACT 7:30 “Afta forty years don pass, one angel appear to am for inside wildaness for Mount Sinai, where one bush for dey burn.
ACT 7:31 As Moses si dis tins, e sopraiz well-well and wen e waka near make e si am well, e hear God vois wey sey,
ACT 7:32 ‘Na mi bi di God wey yor grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob dey woship.’ Moses start to shake and fear nor let am look too mush.
ACT 7:33 But God tell am, ‘Make yu pul yor shoe komot from yor leg, bikos di place wey yu stand so, na holy Groun.
ACT 7:34 I don si as my pipol dey sofa for Egypt and I don hear as dem dey kry, so I don kon save dem. Make yu kom, bikos I won send yu go Egypt back.’
ACT 7:35 “Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.
ACT 7:36 Na dis Moses lead dem komot from Egypt. E still do plenty mirakles for Egypt, di Red Sea and inside di wildaness for forty years.
ACT 7:37 Na dis Moses tell Israel pipol sey, ‘Na from among una God promise sey, E go raiz-up one profet wey go lead una.’
ACT 7:38 Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.
ACT 7:39 But una papa nor gri obey am. Instead, dem nor ansa am, but dem shange dia mind sey dem won go Egypt back.
ACT 7:40 Dem kon tell Aaron, ‘Make yu do juju for us wey go lead us bikos, wi nor know wetin don happen to Moses!’
ACT 7:41 So dem make image wey bi like melu, sakrifice gi-am kon bigin serve di melu wey dem take dia own hand make.
ACT 7:42 “God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’
ACT 7:43 ‘Na bikos of di house wey una build for “Molek and Refan”, wey bi una god and juju wey una dey woship, naim make mi send una go bi slave for Babilon.’
ACT 7:44 God give di Tabanako to awa grand-grand papa dem, di house where dem go for woship am, just as E sey make Moses build am.
ACT 7:45 “Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.
ACT 7:46 God favor David well-well and e sey e go build house for God
ACT 7:47 but na Solomon en pikin kon build am.
ACT 7:48 Wi know sey God nor dey stay for house wey human being build, just as di profet tok,
ACT 7:49 “ ‘Heaven na my chair and na di eart I dey put my leg, so wish kind house una go fit build for mi or wish kind place I go stay?
ACT 7:50 Nor bi mi make all dis tins by mysef?’
ACT 7:51 “Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!
ACT 7:52 E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’
ACT 7:53 Na una receive God law wey E send thru en angels, but una nor obey am.”
ACT 7:54 As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.
ACT 7:55 But Stefen, wey God dey use well-well, look strait go heaven kon si God glory and Jesus Christ wey stand for God rite hand.
ACT 7:56 Naim e shaut, “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Christ, God Pikin, stand for en rite hand.”
ACT 7:57 But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.
ACT 7:58 Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole.
ACT 7:59 As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.”
ACT 7:60 So e fall for groun kon shaut, “My Papa, abeg, make yu nor kount dis sin against dem.” Wen e tok so finish, e kon die.
ACT 8:1 Saul happy wen dem dey kill Stefen. Na from dat day trobol start for di church wey dey Jerusalem and all di bilivers kon skata go Judea and Samaria, but na only di apostles nor run.
ACT 8:2 Some men wey dey holy, karry Stefen go beri afta dem don mourn for am.
ACT 8:3 But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.
ACT 8:4 So di pipol wey skata kon dey go from place to place dey prish di gospel.
ACT 8:5 Filip travel go Samaria main town kon dey prish about di Mezaya give dem.
ACT 8:6 Di pipol wey gada, put dia mind for wetin Filip dey tok, bikos dem don hear and si all di mirakles wey e do.
ACT 8:7 Wiked spirit dey shaut and dey komot from pipol body as dem hear God word and God heal many pipol wey nor fit waka.
ACT 8:8 So all di pipol wey dey di town kon dey happy well-well, bikos of wetin dey happen.
ACT 8:9 E get one strong man for di town wey dem dey koll Simon and e dey do majik wey dey make Samaria pipol sopraiz.
ACT 8:10 Evribody, both small pikin and big pipol, dey bilive wetin e dey do and dem bilive sey, “Na God gi-am pawa!”
ACT 8:11 Dem dey listin to am bikos, e don tey wen e dey use majik take dey do wonders.
ACT 8:12 But wen dem bilive di Good News wey Filip prish about God Kingdom and about Jesus Christ, dem kon baptize di pipol wey bilive.
ACT 8:13 Even Simon sef bilive and afta dem don baptize am, e kon dey waka with Filip, bikos all di mirakles wey God dey do thru Filip, dey sopraiz am.
ACT 8:14 Wen di apostles wey dey Jerusalem hear sey Samaria pipol don receive God word, dem kon send Pita and John go meet dem,
ACT 8:15 so dat dem go pray for di pipol, make dem for receive di Holy Spirit.
ACT 8:16 Bikos for dat time, dem neva receive di Holy Spirit. Na only Jesus name dem take baptize dem.
ACT 8:17 Pita and John put hand for di pipol head and dem kon receive di Holy Spirit.
ACT 8:18 Wen Simon si sey pipol dey receive di Holy Spirit as di apostles put hand for dia head, e give di apostles money
ACT 8:19 kon sey, “Abeg, make una give mi dis pawa, so dat I go fit put my hand for pipol head and dem go receive di Holy Spirit too.”
ACT 8:20 But Pita ansa am, “Make yu and yor money go die! Yu tink sey yu fit buy God gift with money?
ACT 8:21 Yu nor get share for inside dis tin wey God dey give, bikos God don si sey na bad tin yu won take am do.
ACT 8:22 So make yu turn from sin kom meet God and from di bad tins wey dey yor mind and pray make God forgive yu.
ACT 8:23 Bikos I si sey na long-trot and bad belle dey worry yu and sin still full yor mind.”
ACT 8:24 Simon tell Pita, “Make yu pray to God for mi, so dat di tin wey yu tok so, nor go happen to mi.”
ACT 8:25 Afta Pita and John don tell dia story and prish God word finish, dem kon go back to Jerusalem, dey prish God word for inside Samaria, as dem dey go.
ACT 8:26 God angel kon tell Filip, “Get up make yu waka for di wildaness road wey dem dey pass from Jerusalem go Gaza.”
ACT 8:27 So Filip kon dey waka dey go where di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa for Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dia money. E kon woship God for Jerusalem
ACT 8:28 and e dey go house back. E sidan for en horse dey read di book wey Profet Isaya rite.
ACT 8:29 Naim di Holy Spirit tell Filip, “Make yu waka go meet di man.”
ACT 8:30 So Filip run go meet am kon hear am dey read wetin Profet Isaya rite. So e ask di man, “Yu undastand wetin yu dey read so.”
ACT 8:31 Di man ansa, “How I won take undastand, unless pesin tish mi!” E kon tell Filip sey make e kom sidan with am.
ACT 8:32 Na di place wey e dey read for God word bi dis, “Dem lead am like sheep go kill and as sheep pikin dey kwayet wen dem dey shave am, na so too e nor open en mout.
ACT 8:33 Dem disgrace am kon take pawa from en hand. Nobody go fit tok about en shidren or en grand-shidren, bikos dem kill-am wen e still dey yong.”
ACT 8:34 So di man ask Filip, “Abeg tell mi, na who dis profet dey tok about? Na ensef, abi na anoda pesin?”
ACT 8:35 Filip kon start to prish di Good News about Jesus Christ give di man from di place wey e dey read.
ACT 8:36 As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”
ACT 8:37 Filip ansa, “If yu bilive, I go baptize yu.” Di man kon sey, “I bilive sey Jesus Christ na God Pikin.”
ACT 8:38 So e tell di driver make e stop, Filip with am waka go where di wota dey and e kon baptize am.
ACT 8:39 Wen dem kom out from di wota, God Spirit karry Filip komot from der and di man nor si am again, but e kon dey happy as e dey go.
ACT 8:40 Filip si ensef for Azotus and as e dey waka pass for di aria, e kon dey prish di Good News for all di towns till e rish Caesaria.
ACT 9:1 As all dis tins dey happen, Saul still dey tell di disciples sey e go kill dem. E go meet di High Priest
ACT 9:2 kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.
ACT 9:3 As e dey go, one lite from heaven kon shine round where e dey.
ACT 9:4 E fall for groun kon hear one vois wey koll en name, “Saul, Saul, wetin make yu dey ponish mi?”
ACT 9:5 So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!
ACT 9:6 Naw, make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.”
ACT 9:7 Di men wey dey follow am travel, sopraiz dey look, bikos dem hear vois dey tok, but dem nor si anybody.
ACT 9:8 So Saul get up from groun, en eye open, but e nor dey si. En friends hold en hand kon escort am enter Damaskus.
ACT 9:9 E nor si at-all for three days and for dat time, e nor chop or drink anytin.
ACT 9:10 Dat time, e get one disciple for Damaskus and en name na Ananias. God koll am for inside vishon, “Ananias”, e kon ansa, “Na mi bi dis, Oga God.”
ACT 9:11 God tell am, “Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der, make yu look for one man, en name na Saul and e kom from Tarsus. Yu go meet am dey pray for der.
ACT 9:12 I don show am for vishon sey one man wey dem dey koll Ananias go kom meet am and e go put hand for en head, pray for am, make e for fit si again.”
ACT 9:13 But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.
ACT 9:14 E even kollect leta from di priest oga dem, wey e go take katch and trow pipol wey bilive yu, for prison.”
ACT 9:15 But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol.
ACT 9:16 True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.”
ACT 9:17 So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”
ACT 9:18 At wons, sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si. E get up and dem baptize am.
ACT 9:19 Afta e chop finish, en body kon strong again and Saul kon stay Damaskus for some days with di disciple.
ACT 9:20 At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin.
ACT 9:21 Evribody wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, “Dis nor bi di man wey dey kill pipol wey bilive Jesus Christ? Wi tink sey e kom here kon arrest pipol karry go give di priest oga dem.”
ACT 9:22 But Saul still dey prish with pawa. E dey show sey na Jesus Christ bi di Mezaya and di Jew pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am.
ACT 9:23 Afta some days, di Jew pipol kon dey plan to kill-am,
ACT 9:24 but Saul hear wetin dem dey plan. Some pipol dey wosh for di town gate day and nite make dem for fit kill-am wen dem si am.
ACT 9:25 But one nite, di pipol wey dey follow Saul kon put am for basket, trow am down small-small from one small window wey dey near di town fence.
ACT 9:26 Wen e rish Jerusalem, e kon try to join di disciples, but dem dey fear am, bikos dem nor bilive sey e don bi Jesus Christ disciple.
ACT 9:27 So Banabas take Saul go meet di apostles, den e tell dem how Saul take si Jesus Christ for vishon wen e dey go Damaskus and how e bigin prish with boldness about Jesus Christ.
ACT 9:28 Saul stay and waka with dem for Jerusalem and e dey tok with boldness about Jesus Christ.
ACT 9:29 E bigin dey tok and argue with di Jew pipol wey dey speak Greek, but some pipol kon dey try to kill-am.
ACT 9:30 Wen di brodas know about wetin dem dey plan, dem kon take am go Caesaria and from der, dem send am go Tarsus.
ACT 9:31 Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
ACT 9:32 Pita dey travel from one place go anoda and e still go where di bilivers dey for Lydda.
ACT 9:33 E kon meet one man for der, en name na Aeneas wey nor fit waka since wen e bi eight years.
ACT 9:34 Pita kon tell am, “Aeneas, Jesus Christ, wey bi di Mezaya, won heal yu naw. So make yu stand up, karry yor bed!” At wons, e get up kon karry en bed.
ACT 9:35 All di pipol wey dey Lydda and Sharon si wetin happen and dem kon bigin follow Jesus Christ.
ACT 9:36 One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.
ACT 9:37 E sick and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead body, dem kon karry am put for one room for upstair.
ACT 9:38 Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.”
ACT 9:39 So Pita get up follow dem and wen e rish der, dem kon take am go di room for up. All di wimen wey dia husband don die stand near Pita dey kry and dey show am all di dress wey Dorkas make for dem, wen e dey with dem.
ACT 9:40 But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
ACT 9:41 Pita kon hold en hand stand up. E koll di bilivers and all di wimen wey dia husband don die, kon give di woman to dem.
ACT 9:42 Wen evribody for Joppa hear dis tin wey happen, many of dem kon bilive Jesus Christ.
ACT 9:43 Pita kon stay for Joppa for many days with one man wey dem dey koll Simon, wey dey do leda work.
ACT 10:1 One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.
ACT 10:2 E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.
ACT 10:3 One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.”
ACT 10:4 Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.
ACT 10:5 So, send some men go Joppa make dem go koll one man wey en name bi Simon Pita.
ACT 10:6 Di man dey stay with Simon wey dey do leda work and di house dey near di sea.”
ACT 10:7 Wen di angel don go, Kornelius kon koll two of en house boys with one soja wey dey serve am
ACT 10:8 and wen e don tell dem evritin wey happen, e kon send dem go Joppa.
ACT 10:9 For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray,
ACT 10:10 afta sometaim, e kon dey hongry, but di food neva ready. As e dey wait, e kon si vishon.
ACT 10:11 For di vishon, e si sey heaven open and sometin wey bi like tray, wey dem whole for en for korna kon dey kom down small-small.
ACT 10:12 Difren-difren animals wey get four legs and di ones wey dey creep for groun and difren birds dey inside di tray.
ACT 10:13 Den one vois tell am, “Pita, get up, kill make yu chop.”
ACT 10:14 But Pita ansa, “Oga God, I nor go fit, bikos yu know sey since dem born mi, I neva chop anytin wey get blood or wey nor klean.”
ACT 10:15 But di vois tell am, “Wetin God don make klean, make yu nor forbid am.”
ACT 10:16 Dis tin happen three times and di tray kon go back to heaven.
ACT 10:17 As Pita still dey wonder wetin di vishon mean, di men wey Kornelius send kon rish Simon house.
ACT 10:18 Dem ask if anybody wey bi Simon Pita dey di house.
ACT 10:19 As Pita still dey tink about di vishon, di Holy Spirit kon tell am, “Look! Three men dey find yu.
ACT 10:20 Make yu get up go meet dem and make yu follow dem, bikos na Mi send dem kom.”
ACT 10:21 So Pita go down go meet di men kon sey, “Na mi bi di pesin wey una dey look for. Wetin bring una kom?”
ACT 10:22 Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
ACT 10:23 So Pita sey make dem enter house and e welkom dem well-well. Di next day, e kon follow dem go and some brodas for Joppa, follow am go too.
ACT 10:24 Afta dem don travel for one full day, dem kon rish Caesaria. Kornelius don gada all en family and friends dey wait for dem.
ACT 10:25 So as Pita enter di kompond, Kornelius knee down for en front kon dey woship am.
ACT 10:26 But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”
ACT 10:27 As Pita still dey follow am dey tok wen e enter di house, e kon si sey many pipol gada dey wait am.
ACT 10:28 E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.
ACT 10:29 Na dis make wen una send pipol kom koll mi, I nor sey ‘No’. So make una tell mi, ‘Why una koll mi?’ ”
ACT 10:30 Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.
ACT 10:31 E kon sey, ‘Kornelius, God don hear yor prayer and E don remember all di good tins wey yu dey do.
ACT 10:32 So make yu send pipol go Joppa go koll Simon, wey dem dey koll Pita. E dey stay as strenja with Simon wey dey do leda work, wey e house dey near di sea.’
ACT 10:33 So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”
ACT 10:34 Den Pita tell dem, “Naw, I don undastand sey God nor dey opress anybody,
ACT 10:35 but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like.
ACT 10:36 Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.
ACT 10:37 Una know wetin happen from Galilee go rish Judea afta John prish sey,
ACT 10:38 Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
ACT 10:39 All of us si di tins wey e do for Judea and Jerusalem, but dem hang am for three kon kill-am.
ACT 10:40 But God raiz am for di third day kon allow pipol si am.
ACT 10:41 Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.
ACT 10:42 E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die.
ACT 10:43 All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
ACT 10:44 As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message.
ACT 10:45 Di bilivers wey bi Jew wey follow Pita go Joppa kon sopraiz well-well sey Gentile pipol too, fit receive di Holy Spirit,
ACT 10:46 bikos dem dey hear wey dem dey use difren-difren language take dey praiz God. Den Pita sey,
ACT 10:47 “Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
ACT 10:48 So e sey make dem baptize dem for Jesus Christ name. Den di pipol sey make e stay with dem for some days.
ACT 11:1 Di apostles and di brodas wey dey Judea kon hear sey Gentile pipol too don receive God word.
ACT 11:2 So wen Pita rish Jerusalem, di bilivers wey bi Jew kon bigin argue with am sey,
ACT 11:3 “Yu go chop with pipol wey dem nor sekonsaiz.”
ACT 11:4 But Pita tell dem evritin wey happen. E kon sey,
ACT 11:5 “As I dey pray for Joppa I kon si vishon. For inside di vishon, I si sometin wey bi like tray dey kom down small-small from heaven, dem hold am for four korna and e kon stop for my front.
ACT 11:6 As I look inside, I kon si animals wey get four legs, bush meat, di ones wey dey creep and difren-difren birds.
ACT 11:7 I still hear one vois wey tell mi sey, ‘Get up Pita, kill some, make yu chop.’
ACT 11:8 But I ansa, ‘Oga God, I nor fit, bikos since dem born mi, I neva chop anytin wey nor dey klean.’
ACT 11:9 But di vois from heaven kon tell mi again, ‘Wetin God don make klean, make yu nor forbid am!’
ACT 11:10 Dis tin happen three times, den di tray kon go heaven back.
ACT 11:11 Na dat same time three men wey dem send kom meet mi from Caesaria kon rish di house where wi dey stay.
ACT 11:12 Di Holy Spirit kon tell mi sey make I follow dem go. Six brodas for Joppa follow mi go too and wi kon enter di man house.
ACT 11:13 Di man tell us how e si angel wey stand for en house kon tell am, ‘Send pipol go Joppa go koll Simon wey dem dey koll Pita.
ACT 11:14 Wen e kom, e go give yu di message wey God go use take save yu and yor family.’
ACT 11:15 And wen I start to tok, di Holy Spirit kon enter dem, just as e enter us for di first time.
ACT 11:16 So I kon remember wetin di Oga God don use en own mout tell us before sey, ‘John use wota baptize pipol, but God go baptize una with di Holy Spirit.’
ACT 11:17 So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?”
ACT 11:18 Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”
ACT 11:19 All di pipol wey skata komot from Jerusalem for di time wey dem kill Stefen kon travel go far place like Foenicia, Cyprus and Antiok, dey prish give only Jew pipol.
ACT 11:20 But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ.
ACT 11:21 God pawa dey with dem and many pipol wey bilive kon bigin dey follow Jesus Christ.
ACT 11:22 Wen di pipol for di church wey dey Jerusalem hear di news, dem kon send Banabas go Antiok.
ACT 11:23 Wen e rish der kon si how God don bless di pipol, e happy well-well kon enkourage dem sey make dem kontinue to woship God with all dia heart.
ACT 11:24 Banabas na betta pesin, di Holy Spirit dey inside am and e get faith well-well, so many pipol kon bigin follow Jesus Christ.
ACT 11:25 Banabas komot from der go find Saul for Tarsus
ACT 11:26 and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”
ACT 11:27 For di same time, some profets kon go Jerusalem from Antiok.
ACT 11:28 One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.
ACT 11:29 So di disciples, evribody akordin to how e fit do rish, kon sey dem go send money go give di brodas wey dey Judea.
ACT 11:30 Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.
ACT 12:1 For dat time, King Herod katch some pipol wey dey go church kon sey e go kill dem.
ACT 12:2 E kill James, wey bi John broda, with swod.
ACT 12:3 Wen e si sey di Jew pipol happy with wetin e do, e kon arrest Pita too. (Dis tin happen for di time wey dem dey do di bread wey nor get yist feast.)
ACT 12:4 Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.
ACT 12:5 So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite.
ACT 12:6 But for di nite before dem go judge am, dem tie Pita with two shains and e sleep for two sojas centre. Oda sojas still dey di prison front, dey guide am.
ACT 12:7 God angel appear and lite kon shine for di prison. Di angel wake Pita kon tell am, “Get up kwik-kwik!” At wons, di shains fall komot from Pita hand.
ACT 12:8 Di angel sey, “Wear yor klot and yor sandal.” So Pita do wetin di angel tell am. Den di angel sey, “Wear yor koat make yu follow mi.”
ACT 12:9 Pita follow am go outside. Even doh e bilive sey wetin dey happen so na true, e tink sey na dream e dey dream.
ACT 12:10 Afta, en and di angel kon pass di first and di sekond sojas group, den dem kon rish di iron gate wey go di town. Di gate open by ensef and dem go outside kon waka pass one small street, den di angel leave am for der.
ACT 12:11 Wen Pita si sey all dis tins wey dey happen nor bi dream, e kon sey, “Naw I know sey, True-true, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Jew pipol tink sey go happen.”
ACT 12:12 Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary house wey bi John Mark mama, where many pipol gada dey pray for am.
ACT 12:13 Wen e nok di door, Rhoda, one savant girl, kon ansa.
ACT 12:14 Wen di girl hear Pita vois, e kon dey happy sotey e nor remember to open di door, but e run go tell dem sey Pita dey for outside.
ACT 12:15 Dem ansa di girl, “Yu nor know wetin yu dey tok!” But di girl still dey sey na Pita, so dem kon sey, “E go bi en spirit!”
ACT 12:16 But Pita still dey nok and wen dem open di door si am, dem kon sopraiz.
ACT 12:17 E use en hand take tell dem make dem kwayet and e kon tell dem how God take free am from prison. E tell dem, “Make una tell James and all di brodas dis story,” den e leave dem kon go anoda place.
ACT 12:18 Wen day break, di sojas wey dey guide Pita sopraiz well-well and fear katch dem wen dem nor si am again.
ACT 12:19 Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
ACT 12:20 Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.
ACT 12:21 Wen di day wey dem gri to meet am don rish, Herod kon wear en king dress and e kon sidan for en throne dey follow dem tok.
ACT 12:22 But as e dey tok, di pipol wey gada kon dey shaut, “Na god dey tok so-o, nor bi man!”
ACT 12:23 At wons God angel kon nak Herod fall for groun, bikos e nor give God glory and plenty worm kon chop en body till e die.
ACT 12:24 But God word kontinue to dey spread.
ACT 12:25 Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.
ACT 13:1 Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.
ACT 13:2 As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.”
ACT 13:3 Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Saul kon send dem go.
ACT 13:4 So Banabas and Saul wey di Holy Spirit send kon go Seleucia and from der, dem enter ship go Cyprus.
ACT 13:5 Wen dem rish Salamis, dem kon dey prish God word for di Jew sinagog, (John dey der dey help dem.)
ACT 13:6 Wen dem don cross di whole Island go rish Pafos, dem kon si one magician wey bi Jew and na wayo profet. En name na Bar-Jesus,
ACT 13:7 e dey with Sergius Paulus, one Roman offisa wey know book well-well. Di offisa invite Banabas and Saul kom en house, bikos e won hear God word.
ACT 13:8 But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish.
ACT 13:9 But Saul (wey dem dey koll Paul) wey get di Holy Spirit, look Elymas for face
ACT 13:10 kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?
ACT 13:11 Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
ACT 13:12 So wen di Roman offisa si wetin happen, e kon bilive, bikos e sopraiz well-well for wetin dem tish about Jesus Christ.
ACT 13:13 Paul and di pipol wey follow am kon travel from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, but John Mark leave dem kon go back to Jerusalem.
ACT 13:14 Wen dem komot for Perga, dem rish Antiok for Pisidia for Sabat Day kon enter di sinagog go sidan.
ACT 13:15 Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”
ACT 13:16 So, Paul stand up raiz en hand kon sey: “Israel and Gentile pipol wey dey fear God, make una hear wetin I won tok:
ACT 13:17 Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.
ACT 13:18 For forty years, E stay with dem for inside wildaness.
ACT 13:19 Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land.
ACT 13:20 All dis tins happen for four hundred and fifty years. Afta dis, E kon give dem profet wey go judge dem, until Profet Samuel time rish.
ACT 13:21 Di pipol kon ask for king and God give dem Saul, wey bi Kish pikin, wey kom from Benjamin tribe and e rule dem for forty years.
ACT 13:22 Afta God remove am, E kon make David dia king. Na dis man God tok about sey, ‘I don si David, Jesse pikin, di man wey I like well-well and e go do evritin wey I wont.’
ACT 13:23 Na from dis man family God give Israel, Jesus Christ, di Savior wey E promise dem before.
ACT 13:24 Before Jesus kom, John di Baptist don prish to all Israel pipol sey make dem turn from sin kom meet God and make e baptize dem.
ACT 13:25 But as John dey finish en work, e kon tok many times sey, ‘Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Make una si, somebody dey kom afta mi. I nor rish to remove shoe from en leg!’
ACT 13:26 So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
ACT 13:27 Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulers nor know am, so dem kon use wetin dem dey read for Sabat Day, wey di profets tok, take kill-am.
ACT 13:28 Even doh dem nor si anytin wey go make dem kondemn am, dem still tell Pilate make e kill-am.
ACT 13:29 Wen dem don do evritin wey Bible tok about am, dem bring am down from di cross kon put am for grave.
ACT 13:30 But God raiz am from deat
ACT 13:31 and for many days, e appear to di pipol wey dey follow am from Galilee go rish Jerusalem. Na dis pipol kon dey bear witness sey, dis tins na true.
ACT 13:32 And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem.
ACT 13:33 E don do wetin E promise us and dia shidren, wen E raiz Jesus Christ, as dem rite am for Psalms sey, ‘Yu bi my Pikin and today, I don bi yor Papa.’
ACT 13:34 But bikos E don raiz Jesus Christ from deat make e nor for rotin, God kon sey: ‘I go give yu di holy promise wey una fit trust, wey I promise David.’
ACT 13:35 E still tok for anoda Psalms sey, ‘Yu nor go allow yor Pikin wey dey holy, make e rotin.’
ACT 13:36 Bikos David, afta e don do wetin God send am kon do among en pipol, e kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem and e rotin,
ACT 13:37 but di pesin wey God raiz-up, nor rotin.
ACT 13:38 So my pipol, make una know sey, na thru dis Pesin wi dey prish sey, ‘God go forgive una.’
ACT 13:39 True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from.
ACT 13:40 So make una make sure sey wetin di profets tok for groun, nor happen to una:
ACT 13:41 “ ‘Una wey dey laf; make una hear, una go sopraiz till una die! Bikos I go do sometin for una time, sometin wey una nor go bilive even if dem tell una.’ ”
ACT 13:42 As Paul and Banabas dey komot, di pipol kon dey beg dem make dem still kon tok about all dis tins for di next Sabat Day.
ACT 13:43 Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.
ACT 13:44 Di next Sabat Day, nearly evribody for di town gada make dem for hear God word.
ACT 13:45 But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.
ACT 13:46 Paul and Banabas kon use boldness take ansa dem, “E good sey na una wi first prish God word give. But since una rijet am and una nor ready to get life wey nor dey end, wi go-go prish give Gentile pipol.
ACT 13:47 Bikos dis na wetin God don already kommand us sey: ‘I don choose una to bi lite for Gentile pipol, make una bring salvashon kom dis world.’ ”
ACT 13:48 Wen di Gentile pipol hear wetin e tok, dem start to happy kon dey tank God for en word and evribody wey God don choose to get life wey nor dey end, kon bilive.
ACT 13:49 So God word kon dey spread round di whole kountry.
ACT 13:50 But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.
ACT 13:51 So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium.
ACT 13:52 So di disciples kon dey happy and di Holy Spirit full dia life.
ACT 14:1 For Ikonium, Paul and Banabas go inside di Jew sinagog and dem prish sotey many Jew and Greek pipol kon bilive God word.
ACT 14:2 But di Jew pipol wey nor gri bilive, gada di Gentile pipol kon spoil dia mind against Paul and Banabas.
ACT 14:3 Di apostles stay der tey well-well and dem tok with boldness about God, wey show sey dia message about en goodness na true, bikos E kon give dem pawa to do many mirakles and wonders.
ACT 14:4 But di pipol wey dey di town kon divide; some dey di Jew side and some dey di apostle side.
ACT 14:5 Di Gentile and di Jew pipol (with di oga dem wey dey rule dem) kon dey try to sofa and stone di disciples,
ACT 14:6 but wen Paul and Banabas know about am, dem kon run go Lystra and Derbe wey dey for Lykaonia and all di aria wey dey near der
ACT 14:7 and dem kon kontinue to dey prish for der.
ACT 14:8 For Lystra, dem meet one man wey nor fit waka since wen dem born am.
ACT 14:9 Di man dey listin to Paul as e dey tok. Wen Paul look am for eye kon si sey e get faith wey go fit heal am,
ACT 14:10 e tell am, “Stand up.” Di man kon jump up and e bigin waka.
ACT 14:11 Wen di pipol si wetin Paul do, dem kon shaut for Lykaonia language sey, “Awa gods don turn to human being kom meet us.”
ACT 14:12 Dem start to koll Banabas, “Zeus” and Paul, “Hermes”, bikos na Paul dey lead dem.
ACT 14:13 Di priest wey dey woship di god wey dem dey koll Zeus wey en shrine dey outside di town kon bring melu and flowers kom di town gate; so dat en and all di pipol go sakrifice give di apostles.
ACT 14:14 Wen Banabas and Paul hear about di tin wey di pipol won do, dem shaut, tear dia klot kon run go meet di pipol sey,
ACT 14:15 “Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.
ACT 14:16 Before-before, E let difren tribes dey do as dem like,
ACT 14:17 but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”
ACT 14:18 But as Paul and Banabas tok rish, dem nor fit stop di pipol make dem nor do di sakrifice.
ACT 14:19 But afta some Jew pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol mind, dem kon stone Paul, drag am komot from di town, bikos dem tink sey e don die.
ACT 14:20 And as di disciples gada round am, e get up kon waka go back to di town. Di next day, en and Banabas kon komot go Derbe.
ACT 14:21 Afta dem don prish God word for dat town and many pipol don turn from sin kom meet God, dem kon go back to Lystra, Ikonium and Antiok.
ACT 14:22 Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
ACT 14:23 Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.
ACT 14:24 Dem kon leave Pisidia go Pamfilia
ACT 14:25 and wen dem don prish for Perga, dem kon go Atalaya.
ACT 14:26 From der, dem enter ship go Antiok, where dem for first pray for dem, for di work wey dem just finish naw.
ACT 14:27 Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive.
ACT 14:28 So dem stay der for sometaim with di bilivers.
ACT 15:1 Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”
ACT 15:2 Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter.
ACT 15:3 So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.
ACT 15:4 Wen dem rish Jerusalem, di whole church with di apostles and di eldas kon welkom dem, den dem tell dem evritin wey God don use dem do.
ACT 15:5 But some Farisee wey don bilive Christ stand up kon sey, “E good make wi tell Gentile pipol make dem sekonsaiz and do evritin wey Moses Law tok.”
ACT 15:6 Di apostles and di eldas kon whole meetin to tok about di matter.
ACT 15:7 Afta dem don argue well-well about di matter, Pita kon stand up sey, “My brodas, una know sey before-before, na mi God choose make e go prish give Gentile pipol make dem hear and bilive en word.
ACT 15:8 And God, wey know wetin dey inside pipol mind, don show ensef to dem wen E give dem di Holy Spirit, just as E give us
ACT 15:9 and E nor do wayo between wi and dem bikos, E make dia heart klean by faith.
ACT 15:10 So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?
ACT 15:11 Wi bilive sey God save us thru grace wey kom from Jesus Christ, just as E do for dis Gentile pipol too.”
ACT 15:12 Evribody wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Paul dey tok and dem tell dem about di mirakles and wonders wey God use dem do among Gentile pipol.
ACT 15:13 Afta dem don tok finish, James ansa, “Awa brodas, make una hear wetin I won tok.
ACT 15:14 Pita don tell us how God first choose some pipol from Gentile wey go dey tok about am.
ACT 15:15 Dis tins gri with wetin di profets tok before sey:
ACT 15:16 “ ‘Afta all dis tins, I go kom back and I go build David house wey don fall; I go build am with all di san wey skata for groun and e go strong again,
ACT 15:17 so evribody go kom meet God, plus Gentile pipol wey I don koll to bi my pipol.’ God wey make all dis tins, na so E tok
ACT 15:18 and E know sey na so e go bi.
ACT 15:19 “So, I go sey make wi nor make tins hard for Gentile pipol wey just start to serve God,
ACT 15:20 but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
ACT 15:21 Bikos na since awa grand-grand papa dem time dem don dey prish Moses Law for di sinagog for evry Sabat Day.”
ACT 15:22 So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas.
ACT 15:23 Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!
ACT 15:24 Wi hear sey some pipol kom meet una sey dem kom from us, even doh wi nor send dem. Dem dey konfuse and tell una wetin go disturb una mind.
ACT 15:25 So all of us kon gri sey make wi choose pipol wey go follow Banabas and Paul, wey bi awa friend, kom meet una.
ACT 15:26 Dis men dey risk dia life, bikos of awa Oga God Jesus Christ name.
ACT 15:27 So wi send Judas and Silas wey go tell una all dis tins by demsef.
ACT 15:28 Bikos wi and di Holy Spirit nor won put heavy load for una head, so na dis small advise wi dey give una:
ACT 15:29 ‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”
ACT 15:30 So wen dem don send dem go, dem kon go Antiok and afta dem gada evribody, dem kon give dem di leta.
ACT 15:31 Bikos of wetin dem rite put for di leta, all di pipol happy wen dem read am out.
ACT 15:32 But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong.
ACT 15:33 Afta dem don stay der tey small, di brodas kon send dem back with peace to di pipol wey send dem kom.
ACT 15:34 But Silas sey e go still stay der for sometaim.
ACT 15:35 Paul, Banabas and odas kon still stay for Antiok dey tish and prish God word.
ACT 15:36 Afta some days, Paul kon tell Banabas, “Make wi go back go visit di brodas for all di town wey wi for prish God word, so dat wi go know how dem dey.”
ACT 15:37 Banabas won kon karry John Mark follow body,
ACT 15:38 but Paul sey make dem nor karry am, bikos na so e take leave dem for Pamfilia before and e nor follow dem do di work.
ACT 15:39 Dis matter kon kause sirious kworel, sotey dem kon separate. Banabas take Mark follow body and dem kon enter ship go Cyprus,
ACT 15:40 but Paul choose Silas and dem go meet di brodas and sistas kon pray make God bless dem.
ACT 15:41 Paul pass thru Siria and Silisia dey enkourage di pipol wey dey di church dem for der.
ACT 16:1 Paul kon still go Derbe and Lystra. One disciple wey dem dey koll Timoti dey der. En mama na Jew wey bilive Christ, but en papa, na Greek.
ACT 16:2 Di brodas wey dey Lystra and Ikonium dey tok good about am.
ACT 16:3 Paul wont make Timoti follow am, so e sekonsaiz am, bikos di Jew pipol wey dey for di aria, know sey en papa na Greek.
ACT 16:4 As dem dey go from town to town, dem kon dey pass di message wey di apostles and eldas for Jerusalem send to all di Gentile pipol wey bilive Christ sey, make dem obey.
ACT 16:5 So di pipol for di church dey strong more-more for faith and dem kon dey plenty evriday.
ACT 16:6 Dem pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia.
ACT 16:7 Wen dem rish Mysia, dem kon try to enter inside Bitynia, but Jesus Christ Spirit nor allow dem enter,
ACT 16:8 naim dem pass thru Mysia kon face Troas.
ACT 16:9 Paul si dis vishon for nite: One man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, “Make yu kom help us for Masidonia!”
ACT 16:10 Wen Paul si dis vishon finish, wi kon try to go Masidonia. Wi kon bilive sey God don koll us make wi go prish di Good News to di pipol wey dey der.
ACT 16:11 Wi travel for wota from Troas and awa ship kon from der go Samotrace and di next day, wi go Neapolis
ACT 16:12 and from der, to Filippi wey bi nomba one town for Masidonia, wey Rome dey rule. Wi stay for dis town for some days.
ACT 16:13 Wen Sabat Day rish, wi komot from di town go di wotaside, where wi tink sey wi go si where dem for dey pray, naim wi sidan kon start to dey tok to di wimen wey gada for der.
ACT 16:14 E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.
ACT 16:15 Afta en and en family don baptize, e kon beg us sey, “If una don asept mi as pesin wey bilive Christ, make una kon stay for my house.” So e beg us until wi gri.
ACT 16:16 One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.
ACT 16:17 Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey, “Dis pipol na God savants o-o, dem dey prish to una about how una go take save.”
ACT 16:18 E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.
ACT 16:19 But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.
ACT 16:20 Den dem drag dem go meet di judge dem kon sey, “All dis men dey kause wahala for dis town. Dem bi Jew
ACT 16:21 and dem dey tish law wey nor bi awa own, since wi bi Rome pipol.”
ACT 16:22 All di pipol wey gada for der kon join put mout against dem and di judge dem kon give orda sey, make dem remove Paul and Silas klot komot for dia body and flog dem with heavy stik.
ACT 16:23 Afta dem don flog dem well-well, dem put dem for prison kon tell di warda make e guide dem well-well.
ACT 16:24 Bikos of dis strong orda, di warda put dem for inside-inside di prison kon hook dia leg with big-big shains.
ACT 16:25 Wen mid-nite rish, Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem.
ACT 16:26 At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too. Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison, kon luz.
ACT 16:27 Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run.
ACT 16:28 But Paul shaut, “Make yu nor kill yorsef, all of us still dey for here!”
ACT 16:29 Naim di warda sey make dem bring lite and e rush enter inside di prison kon fall for Paul and Silas front dey shake.
ACT 16:30 E bring dem kom outside kon ask, “My oga dem, wetin I go do to dey save?”
ACT 16:31 Dem ansa am, “Bilive Jesus Christ and yu go save, both yu and all yor family.”
ACT 16:32 Den, dem prish God word give en and all di pipol wey dey en house.
ACT 16:33 Dat nite, di warda kon wosh all dia sore; den en and en family kon baptize.
ACT 16:34 Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God.
ACT 16:35 Wen day break, di judge dem kon send sojas sey, “Make una go release doz men.”
ACT 16:36 Di warda tell Paul, “Di judge dem don give orda sey make wi free una. So make una kon dey go.”
ACT 16:37 But Paul tell di sojas, “Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase, even doh sey wi bi Rome pipol, dem still trow us for prison. Naw, dem won free us from back make pipol nor for know? Wi nor gri! Make dem kom here by demsef kon release us!”
ACT 16:38 Di sojas kon ripot wetin Paul tok give di judge dem. Fear katch dem wen dem hear sey Paul and Silas na Rome pipol,
ACT 16:39 so dem kon beg dem sey make dem nor vex. Afta dem bring dem kom out, dem kon beg dem well-well sey make dem leave di town.
ACT 16:40 Wen dem don komot for prison, dem enter Lydia house and wen dem si di brodas, dem enkourage dem before dem leave di town.
ACT 17:1 Afta dem pass Amfipolis and Apollonia, dem kon rish Tesalonika where one Jew sinagog dey.
ACT 17:2 Paul go meet di Jew pipol for di sinagog as e dey do before and for three Sabat Day, e kon dey tish dem God word,
ACT 17:3 dey show dem how God word sey Christ must sofa and e go raiz from grave. E tell dem, “Dis Jesus wey I dey tell una about so, naim bi di Christ.”
ACT 17:4 Some among dem wey bilive kon join Paul and Silas and many Greek pipol wey dey fear God and some big-big wimen, join dem too.
ACT 17:5 But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.
ACT 17:6 Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and some for en brodas go meet di town oga, dey shaut, “All dis pipol wey don start wahala for di world, don rish here too
ACT 17:7 and Jason put dem for en house like visitor! Dem dey do wetin dey against Caesar law, dey tok sey anoda king dey wey en name bi Jesus Christ!”
ACT 17:8 Dem kause konfushon among di pipol wey gada and di town oga dem wey hear all dis tins.
ACT 17:9 Afta di oga dem don kollect money from Jason and di brodas, dem kon allow dem go.
ACT 17:10 At wons, di brodas send Paul and Silas go Berea for nite. Wen dem don rish der, dem kon go di Jew sinagog.
ACT 17:11 Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.
ACT 17:12 Na so many of dem take bilive, even with some big-big men and wimen wey bi Greek.
ACT 17:13 But wen di Jew pipol wey dey for Tesalonika hear sey Paul don rish Berea dey prish God word, dem kon go der go kause wahala and spoil di pipol mind.
ACT 17:14 Naim di brodas send Paul go di wotaside, but Silas and Timoti still stay for Berea.
ACT 17:15 Di pipol wey follow Paul, escort am go rish Atens and afta, e orda dem sey make Silas and Timoti kom meet am kwik-kwik for der, so dem kon go back.
ACT 17:16 As Paul dey Atens dey wait for dem, e kon dey vex for en spirit, bikos e si sey na so-so juju full di town.
ACT 17:17 So e tok to di Jew and Gentile pipol wey dey fear God wey dey inside di sinagog and e still tok to evribody wey dey di market.
ACT 17:18 So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.)
ACT 17:19 So dem take Paul go Areopagus kon tell am, “Wi beg, make yu tell us about dis new tin wey yu dey tish so?
ACT 17:20 Bikos di tins wey yu dey tok, wi neva hear am before and wi like to know wetin dem mean.”
ACT 17:21 (Atens pipol and odas wey dey der, nor get any oda work pass make dem sidan dey tok story about any new tin wey dey happen.)
ACT 17:22 So Paul stand for Areopagus front kon sey, “My pipol wey dey for Atens, I si sey una like God matter well-well.
ACT 17:23 Bikos as I waka round dey look all di tins wey una dey woship, I even si one shrine wey dem rite put sey: ‘To di god wey pipol nor know.’ So wetin una dey woship wey una nor know, naim I kon tell una about today.
ACT 17:24 God wey make di world and evritin wey dey inside, wey bi di Oga God for heaven and eart, nor dey stay inside house wey human being build
ACT 17:25 and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath.
ACT 17:26 Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,
ACT 17:27 so dat as dem dey look for God, dem go si am, even doh E nor dey far from all of us.
ACT 17:28 Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’
ACT 17:29 So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make.
ACT 17:30 God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am,
ACT 17:31 bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”
ACT 17:32 Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, some kon dey laf, but odas sey, “Yu go tell us dis matter again.”
ACT 17:33 So Paul kon komot from Areopagus.
ACT 17:34 But some pipol wey bilive Christ kon join am. Inside dis pipol wey bilive so, na Dionysius wey bi memba for Areopagus and one woman wey dem dey koll Damaris, with oda pipol wey join dem.
ACT 18:1 Afta dis tins, Paul komot from Atens go Korint.
ACT 18:2 For der, e kon si one Jew wey dem dey koll Akwila, wey kom from Pontus and e just kom back from Italy with en wife Priscilla, bikos Klaudius orda sey make all Jew pipol komot from Rome. Paul go meet dem
ACT 18:3 and bikos dem dey do di same work, e kon stay with dem dey follow dem work (na tent dem dey make sell).
ACT 18:4 E dey tok to both Jew and Greek pipol for di sinagog evry Sabat Day, so dat dem go bilive.
ACT 18:5 Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ.
ACT 18:6 Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”
ACT 18:7 Den Paul komot for di sinagog go Titus Justus house; di man na Gentile wey dey woship God and en house dey near di sinagog.
ACT 18:8 Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.
ACT 18:9 Jesus kon tell Paul for vishon for nite, “Make yu nor kwayet bikos of fear, but make yu open yor mout dey tok,
ACT 18:10 I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”
ACT 18:11 So Paul stay der for one year and six monts dey tish di pipol God word.
ACT 18:12 Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat.
ACT 18:13 Dem sey, “Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!”
ACT 18:14 But just as Paul won start to tok, Gallio kon tell di Jew pipol sey, “If na bikos of one offence or sirious wayo, I for listin to una komplain,
ACT 18:15 but since na matter about word, name and una own law, make una go setol am by unasef. I nor go judge all doz kind tins!”
ACT 18:16 So e drive dem komot from di judgement seat.
ACT 18:17 Dem kon seize Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di judgement seat front. But Gallio do like sey all dis tins nor koncern am.
ACT 18:18 Afta Paul don stay many days for Korint, e kon tell all di brodas bye-bye, den e enter ship go Siria, but Priscilla and Akwila follow am go. For Cenchrea, e kon kut en hair bikos e make vow.
ACT 18:19 Wen dem rish Efesus, Paul leave Priscilla and Akwila for der, but en ensef enter di sinagog go follow di Jew pipol tok.
ACT 18:20 Wen dem sey make e stay with dem small, e nor gri,
ACT 18:21 but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus
ACT 18:22 and wen e rish, Caesaria pass go Jerusalem go salot di pipol for di church wey dey der, before e go Antiok.
ACT 18:23 Afta e don stay small for der, Paul komot kon travel pass all di aria wey dey Galatian and Frigia, dey enkourage all di disciples.
ACT 18:24 E get one Jew man, en name na Apollos and e from Alexandria go Efesus. Apollos sabi tok and e know di Bible well-well.
ACT 18:25 Dem don tish am about Jesus and na with high spirit e take dey tok and tish about Jesus Christ, but na only John baptizim e know rish.
ACT 18:26 E kon dey tok with boldness for di sinagog, but wen Priscilla and Akwila hear am dey tok, dem koll am go korna kon esplain God word gi-am well-well.
ACT 18:27 Wen Apollos one cross go Akaia, di brodas enkourage am kon gi-am leta make e give di disciples, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivers,
ACT 18:28 bikos e nor gri with wetin di Jew pipol dey tok for publik and e show dem from di Bible sey na Jesus Christ, bi di Mezaya.
ACT 19:1 For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples
ACT 19:2 kon ask dem, “Una don receive di Holy Spirit, since una don bilive Christ?” Dem ansa, “No! Wi neva even hear sey Holy Spirit dey.”
ACT 19:3 Paul ask dem, “Na how dem kon take baptize una?” Dem ansa, “Na John baptizim.”
ACT 19:4 Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”
ACT 19:5 Wen dem hear wetin Paul tok, dem kon baptize dem with Jesus Christ name
ACT 19:6 and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.
ACT 19:7 (Na twelf disciples Paul follow tok.)
ACT 19:8 So Paul enter di sinagog kon dey tok with boldness for three monts. E dey show di pipol how dem go take bilive God Kingdom.
ACT 19:9 But wen some sturbon pipol nor gri bilive, dem kon dey spoil Jesus Christ name for all di pipol front, so Paul with en disciples kon leave dem. Paul dey take en disciples follow body evriday, go tish for Tirannus Hall.
ACT 19:10 Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
ACT 19:11 Dat time, God use Paul dey do many wonderful mirakles,
ACT 19:12 even handkachief and klot wey dem take tosh Paul body, dey heal sick pipol and drive evil spirit from pipol body, wen dem use am tosh dem.
ACT 19:13 But some Jew wey dey waka about kon try to koll Jesus Christ name for pipol wey evil spirit dey disturb dey sey, “I kommand yu with Jesus Christ name wey Paul dey prish.”
ACT 19:14 (So, Skeva wey bi Jew priest, get seven sons wey dey do dis kind tin.)
ACT 19:15 But di evil spirit ansa dem, “Yes! I know who Jesus Christ bi, I still know Paul too, but who una bi?”
ACT 19:16 Naim di man wey di evil spirit dey inside en body kon jump for dia body beat dem well-well, until dem start to beg. E beat dem till dem run komot from di house with nakednes and all dia body full with sore.
ACT 19:17 Wen evribody wey dey stay Efesus, both Jew and Greek, hear di story, fear katch dem and Jesus Christ name kon dey reign.
ACT 19:18 Pipol wey nor bilive, kom out kon dey konfess all di bad tins wey dem dey do.
ACT 19:19 Some wey dey do majik, bring all dia book kon burn dem to ashes for evribody front. Wen dem add di prize for all di book, e rish 50,000 silva koins.
ACT 19:20 So God word kon dey grow more-more and dem kon dey win many souls.
ACT 19:21 Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”
ACT 19:22 So, afta e send two men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon still stay Asia small.
ACT 19:23 Dat time sirious wahala happen bikos of “Christ Way” wey dem dey prish.
ACT 19:24 E get one man, en name na Demetrius and e dey mold silva image. Na dis man mold Artemis shrine and dey help pipol wey dey mold, make plenty money.
ACT 19:25 Di man kon gada all di pipol wey dey mold, with oda men wey dey do dat kind work, den e tell dem, “My pipol, una know sey na dis business wi take dey chop.
ACT 19:26 And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all.
ACT 19:27 So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”
ACT 19:28 Wen di pipol hear dis tins, dem vex well-well kon start to shaut, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!”
ACT 19:29 Di whole town kon dey shake with nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey escort Paul.
ACT 19:30 But wen Paul one enter di stadium, di disciples nor allow am.
ACT 19:31 Even some for di oga dem wey bi en friend, send message go meet am sey, make e nor enter di stadium.
ACT 19:32 Na so all di pipol dey shaut anyhow and konfushon kon full evriwhere, many pipol wey gada dey shaut, nor even know why dem gada.
ACT 19:33 Some pipol sey na about Alexanda, bikos di Jew pipol don push am go front. Alexanda wave en hand kon sey, make dem kwayet, make e for fit tok to defend di Jew pipol.
ACT 19:34 But wen dem si sey na Jew e bi, dem kon start to shaut again, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!” Dem shaut like dis rish two hours.
ACT 19:35 “Afta di town sekretary don make di pipol kwayet, e kon sey, My pipol wey dey Efesus, wish pesin dey among una wey nor know sey na Artemis bi Efesus god wey fall from heaven?
ACT 19:36 So bikos nobody fit argue dis matter, make una kwayet and make una nor do anytin wey nor get head.
ACT 19:37 Una don bring dis men kom here, nor bi bikos dem spoil di temple or curse awa goddes.
ACT 19:38 If Demetrius and di pipol wey dey with am get any komplain against anybody, kourt dey and judge dem dey der too. So make dem take dia kase go der.
ACT 19:39 But if una wont anytin wey pass dis one, na kourt dem go for setol am.
ACT 19:40 Bikos dem fit take all of us go kourt today sey wi dey rayot, bikos wi nor get any rizin for dis konfushon wey dey happen so.”
ACT 19:41 Afta e tok finish, e kon sey make evribody go dia house.
ACT 20:1 Afta di wahala for Efesus, Paul send for di disciples and afta e enkourage dem, e tell dem bye-bye kon komot der go Masidonia.
ACT 20:2 Afta e waka round di aria, e enkourage di bilivers wey dey der kon go Greece.
ACT 20:3 E stay for der for three monts. Bikos Jew pipol don plan to wait make dem katch am, as e won enter ship go Siria, e kon go back thru Masidonia.
ACT 20:4 Pipol wey follow Paul go, na Sopata, wey bi Pyrrhus pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekundus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti with Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.
ACT 20:5 All dis pipol don go for front go wait us for Troas.
ACT 20:6 Wi enter ship from Filippi afta di Passova Feast and afta five days, wi meet dem for Troas kon stay der for seven days.
ACT 20:7 For di first day for di week, wen wi whole meetin to break bread togeda, Paul start to tok with di pipol and bikos e won go di next day, e kon prish till mid-nite.
ACT 20:8 (For di room for upstair where wi for dey meet, lamp many for der),
ACT 20:9 one boy wey dem dey koll Eutikus, sidan for di window kon dey sleep as Paul dey prish. Di sleep karry am go, so e fall from di three story and wen dem rush go karry am, dem si sey e don die.
ACT 20:10 But Paul go down, liedan on-top di boy kon put en hand round am sey, “Make una nor worry, bikos e still dey alive!”
ACT 20:11 Den Paul go upstair and afta e don break bread with dem, e follow dem tok till day break. Den e kon komot from der.
ACT 20:12 Dem take di boy go house kon dey happy sey e dey alive.
ACT 20:13 Wi waka go where di ship dey kon go Asoss, so dat wi go karry Paul for der, bikos e plan sey e go pass land go der.
ACT 20:14 Wen e meet us for Asoss, wi karry am for di sheep kon go Mitilene.
ACT 20:15 From der, wi move and di next day, wi kon rish Miletus.
ACT 20:16 Paul don sey e go travel pass Efesus make e for nor spend time for Asia, bikos e dey hurry make e for kwik rish Jerusalem for Pentekost Day.
ACT 20:17 From Miletus, e send messenja go Efesus sey make di eldas wey dey di church kon meet am der.
ACT 20:18 Wen dem kom, e tell dem, “All of una know how I dey live my life since di time wey I dey with una and from di first day wey I enter Asia;
ACT 20:19 how I nor dey karry body up as I dey serve Jesus with pain and wahala wey I dey face, bikos of di wiked plan wey Jew pipol get for mi.
ACT 20:20 Una know sey I nor stop to dey tell una anytin wey go help una and I tish una for publik and for una house.
ACT 20:21 I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.
ACT 20:22 Naw, di Spirit dey lead mi go Jerusalem, even doh I nor know wetin go happen to mi for der,
ACT 20:23 escept sey di Holy Spirit dey warn mi sey, from town to town, na prison and sofa dey wait for mi.
ACT 20:24 But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.
ACT 20:25 “Naw, I know sey non of una wey I prish God kingdom give, go si mi again.
ACT 20:26 So, I won tell una naw sey, nobody blood dey for my head.
ACT 20:27 Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.
ACT 20:28 Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
ACT 20:29 I know sey afta I don go, wiked pipol with bad mind go kom join una and dis pipol nor go sorry for di ship.
ACT 20:30 Even among una, some men go stand dey tish lie-lie tins kon draw pipol follow body.
ACT 20:31 So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.
ACT 20:32 Naw, I leave una for God hand, so make en word wey get grace, keep una. Dis word wey get grace fit make una grow and get share with all God pipol.
ACT 20:33 Since una know mi, I nor put eye for anybody gold, silva or koat.
ACT 20:34 Una know sey na dis my hand I take dey work and get evritin wey I wont and even dey help pipol wey dey with mi.
ACT 20:35 Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
ACT 20:36 Wen e tok all dis tins finish, e knee down with all of dem kon pray.
ACT 20:37 All of dem start to kry, as dem draw Paul near body kon dey kiss am.
ACT 20:38 Wetin Paul tok, make dem weak, bikos e sey, “Una nor go si mi again.” So dem follow am go rish where di ship dey.
ACT 21:1 Afta wi don leave dem, wi enter ship kon travel go Kos. Di next day, wi go Rhodes and from der, wi kon go Patara.
ACT 21:2 Wi si one ship dey cross go Foenicia, so wi kon enter am.
ACT 21:3 Afta wi rish Cyprus, wi kon leave der travel go Siria, kom stop for Tyre, bikos di ship won put load down.
ACT 21:4 Wi kon go find di disciples wey dey for di town, wen wi si dem, wi stay with dem for seven days. Dem kon tell Paul many times sey make e nor go Jerusalem.
ACT 21:5 Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside
ACT 21:6 kon tell dem bye-bye and as wi enter ship, dem kon go back to dia house.
ACT 21:7 Wi kontinue awa journey from Tyre go rish Ptolemais and wen wi don greet di brodas, wi stay with dem for one day.
ACT 21:8 Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.
ACT 21:9 (E get for dotas wey neva marry, wey dey profesai.)
ACT 21:10 As wi stay der for some days, one profet wey en name na Agabus kom from Judea.
ACT 21:11 E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ”
ACT 21:12 Wen wi hear wetin e tok, wi and di pipol wey dey der kon beg Paul sey make e nor go Jerusalem.
ACT 21:13 But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”
ACT 21:14 Bikos wi nor fit stop am again, wi kon keep kwayet and only en kon sey, “Wetin God wont make e happen, go happen.”
ACT 21:15 Afta dat day, wi prepare kon go Jerusalem.
ACT 21:16 Some disciples from Caesaria follow us go, dem kon take us go Mnason house for Cyprus. Dis Mnason dey among di first disciples and wi stay der with am.
ACT 21:17 Wen wi rish Jerusalem, di brodas welkom us with happiness.
ACT 21:18 Di next day, Paul kon follow us go si James and all di eldas wey dey der.
ACT 21:19 Wen Paul don greet dem, e kon start to tok di story about wetin God don do for Gentile pipol thru en ministry.
ACT 21:20 Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey praiz God. Den, dem tell am, “Yu si, awa broda, many Jew don bilive and dem still dey obey di law!
ACT 21:21 Dem hear sey yu dey tish Jew pipol wey dey stay with Gentile pipol, sey make dem trowey Moses Law; make dem nor sekonsaiz dia shidren again and make dem nor follow awa laws again.
ACT 21:22 So, wetin wi go do? Bikos dem go really hear sey yu don kom.
ACT 21:23 So make yu do wetin wi won tell yu: For men dey with us here wey make vow;
ACT 21:24 take dem follow body make una go do wetin Moses Law tok and make yu pay all di money wey dem spend take shave dia head. Den, evribody go know sey all di story wey dem hear about yu, nor bi true and dem go si sey yu yorsef dey obey di law.
ACT 21:25 But for Gentile pipol wey don bilive, wi don rite leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.”
ACT 21:26 Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
ACT 21:27 Wen di seven days don dey finish, di Jew pipol wey kom from Asia kon si am for di temple, naim dem start wahala and pipol kon gada. Dem seize Paul
ACT 21:28 dey shaut sey, “Israel pipol, make una kom o-o! Dis na di man wey dey tish pipol for evriwhere, about tins wey dey against awa pipol, awa law and against dis Temple. Even sef e don take Greek pipol enter inside di temple kon make dis Holy Place dirty.”
ACT 21:29 (Bikos dem si Trofimus wey kom from Efesus for di town with am before, so dem kon tink sey, Paul don karry am enter di temple.)
ACT 21:30 Di whole town start to shake and all di pipol kon gada. Dem seize Paul, drag am komot from di temple kon klose di door.
ACT 21:31 As dem dey try to kill-am, news kon rish di kommanding offisa for di Roman soja wey dey guide di town sey, di whole Jerusalem don skata.
ACT 21:32 At wons, e karry plenty sojas and ofisas kon run go where di pipol gada. Wen dem si di kommanding offisa and di sojas, dem kon stop to beat Paul.
ACT 21:33 Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do.
ACT 21:34 Some pipol among di crowd kon dey tok difren-difren tins and wen di kommanding offisa nor fit know wetin kause di wahala, e kon give orda sey, make dem karry Paul go barrak.
ACT 21:35 Wen e rish di step for di temple, di sojas kon karry Paul, bikos of di crowd wey won kill-am.
ACT 21:36 So dem follow di sojas for back kon dey shaut, “Kill-am!”
ACT 21:37 As dem won karry Paul enter di barrak, e kon ask di kommanding offisa, “I go fit tok to yu first?” Di offisa ansa, “So yu dey hear Greek language?
ACT 21:38 So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?”
ACT 21:39 Paul ansa, “I bi Jew wey kom from Tarsus wey dey Silisia. I bi citizin for dis town and dem know mi well-well. Abeg allow mi follow di pipol tok.”
ACT 21:40 Wen di kommanding offisa allow am, Paul kon stand for di step, wave en hand sey make dem kwayet. Wen evriwhere don kwayet, e kon use Aramaik language follow dem tok.
ACT 22:1 “My brodas and fada, make una hear mi as I dey defend mysef.”
ACT 22:2 (Wen dem hear sey e dey tok to dem with Aramaik language, dem kon kwayet well-well.) Den Paul sey,
ACT 22:3 “I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.
ACT 22:4 I sofa Christians and I dey kill pipol wey dey serve God, dey tie pipol trow for prison, weda dem bi man or woman
ACT 22:5 and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arrest pipol wey bilive Christ kon bring dem kom Jerusalem put for prison.
ACT 22:6 As I dey go, near Damaskus, around aftanoon, one kind lite from heaven kon shine round mi.
ACT 22:7 Den I fall for groun kon hear one vois wey sey, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi?’
ACT 22:8 I ansa, ‘Who yu bi Oga God?’ E kon sey, ‘I bi Jesus Christ wey kom from Nazaret, wey yu dey ponish.’
ACT 22:9 Di pipol wey follow mi si di lite, but dem nor undastand di vois wey dey tok to mi.
ACT 22:10 So I ask am, ‘Oga God! Wetin yu wont make I do?’ God ansa, ‘Get up make yu go Damaskus; for der, dem go tell yu evritin wey God don choose sey yu go do.’
ACT 22:11 Bikos of how di lite shine for my eye, I nor fit si again, so di pipol wey dey follow mi kon whole my hand go Damaskus.
ACT 22:12 One man wey dem dey koll Ananias, wey dey holy and dey serve God akordin to di law and di Jew pipol wey dey stay der, dey tok good about am.
ACT 22:13 Na di man kom meet and stand near mi sey, ‘Broda Saul, make yu bigin si again!’ So for dat same time, I look up kon si am.
ACT 22:14 Den e sey, ‘God wey awa grand-grand papa dem serve don already choose yu to do wetin e wont, so dat yu go take yor eye si di Raitious Pesin. So make yu hear and listin to am,
ACT 22:15 bikos yu go bi witness to all di pipol, about wetin yu don si and hear.
ACT 22:16 Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’
ACT 22:17 Wen I go Jerusalem back and dey pray for di temple, I kon si vishon
ACT 22:18 and Jesus Christ sey, ‘Make yu komot for Jerusalem kwik-kwik, bikos dem nor go asept wetin yu dey tok about mi.’
ACT 22:19 I ansa, ‘Oga God, dem diasef know sey I dey beat and trow pipol wey bilive yu put for prison.
ACT 22:20 And wen dem kill yor savant Stefen, I stand der support dem kon keep dia koat for dem.’
ACT 22:21 But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”
ACT 22:22 As e tok finish, pipol wey gada dey listin to am kon dey shaut, “Karry dis man komot! Make dem nor allow am live!”
ACT 22:23 As dem dey shaut dey vex pul shirt and trowey san-san,
ACT 22:24 di kommanding offisa kon give orda sey make dem take Paul go inside barrak. E sey make dem flog and ask Paul kweshon, so dat dem go fit know why di pipol dey shaut for Paul head like dat.
ACT 22:25 Wen dem don put am for groun make dem start to flog am, Paul kon ask di soja wey stand near am, “E dey rite make una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva judge en kase?”
ACT 22:26 Wen di soja hear dis, e go tell di kommanding offisa, “Wetin yu won do so? Dis man kom from Rome o-o.”
ACT 22:27 So di kommanding offisa ask Paul, “Tell mi, yu bi Roman citizin?” Paul ansa, “Yes.”
ACT 22:28 Di kommanding offisa kon sey, “Na big money I spend to bi Roman citizin.” Paul ansa, “But dem born mi for Rome.”
ACT 22:29 Den doz men wey bi won ask am kweshon kon komot and fear katch di kommanding offisa wen e know sey Paul, wey dem tie, na Roman citizin.
ACT 22:30 Di next day, bikos di kommanding offisa won know di rizin wey make di Jew pipol dey akuiz Paul, e release am kon orda di priest oga dem and di whole kansol make dem gada. So e bring Paul kon stand for dia front.
ACT 23:1 Paul look di kansol pipol kon tell dem, “My brodas, I dey live my life with klean mind for God eye kon rish today.”
ACT 23:2 Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout.
ACT 23:3 So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?”
ACT 23:4 Di pipol wey stand near am kon sey, “Yu dey curse God High Priest?”
ACT 23:5 Paul ansa, “I nor know before sey naim bi di High Priest, bikos God word sey, ‘Make yu nor tok bad about di pesin wey dey rule yor pipol.’ ”
ACT 23:6 Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”
ACT 23:7 Wen e tok dis tin, kworel kon start between di Farisee and di Sadusi pipol and di kansol kon divide.
ACT 23:8 (Bikos Sadusi pipol bilive sey pipol wey don die, nor go wake again and dem nor bilive sey anytin like angel or spirit dey sef, but Farisee pipol bilive all dis tins.)
ACT 23:9 So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”
ACT 23:10 Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.
ACT 23:11 For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.”
ACT 23:12 Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.
ACT 23:13 Di pipol wey make dis bad plan pass forty.
ACT 23:14 Dem go meet di priest oga dem and di eldas tell dem sey, “Wi don swear sey wi nor go chop anytin until wi kill Paul.
ACT 23:15 So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”
ACT 23:16 But wen Paul sista pikin hear about dis plan, e run go inside di barrak go tell Paul.
ACT 23:17 Paul koll one soja oga kon tell am, “Take dis boy go meet di kommanding offisa, bikos e get sometin wey e won tell am.”
ACT 23:18 So di soja oga take di boy go meet di kommanding offisa kon sey, “Paul, wey dey prison, sey make I bring dis boy kon meet yu, bikos e get sometin wey e won tell yu.”
ACT 23:19 Di kommanding offisa whole di boy for hand go one korna kon ask am, “Wetin yu won tell mi?”
ACT 23:20 Di boy ansa, “Jew pipol dey plan sey dem go ask yu make yu bring Paul kom di kansol tumoro, like sey dem won ask am kweshon again.
ACT 23:21 So make yu nor allow dem deceive yu, bikos dem pass forty wey hide for bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anytin, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu.”
ACT 23:22 So di kommanding offisa tell di boy make e dey go kon warn am sey, “Nor tell anybody sey yu don ripot dis matter give mi.”
ACT 23:23 Den e koll two soja oga kon tell dem, “For nine oklok dis nite, make una ready two hundred sojas wey go-go Caesaria, plus seventy, wey go ride horse and two hundred, wey go karry spear.
ACT 23:24 Make una arrange horse wey Paul go sidan put, so dat una go fit guide am well-well go meet Felix wey bi di govnor.”
ACT 23:25 E rite leta like dis:
ACT 23:26 “From Klaudius Lysias to Govnor Felix, I salot yu!
ACT 23:27 Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin.
ACT 23:28 Bikos I won know di offence wey e kommit, I kon karry am go dia kansol.
ACT 23:29 I kon si sey en offence, na about wetin dem dey argue about for dia law, but e nor do anytin wey rish to kill-am or put am for prison.
ACT 23:30 Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”
ACT 23:31 So di sojas karry Paul for nite until dem rish Antipatris, just as dia oga kommand dem.
ACT 23:32 Di next day, di two soja oga leave di men wey dey ride horse follow Paul and dem kon go dia barrak back.
ACT 23:33 Wen di men wey dey ride horse rish Caesaria, dem kon take Paul and di leta give di govnor.
ACT 23:34 Wen di govnor don read di leta, e ask dem where Paul from kom. Wen e hear sey e kom from Silisia,
ACT 23:35 e kon sey, “I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here.” Den e orda sey make dem guide Paul for inside Herod palis.
ACT 24:1 Wen five days don pass, Ananias, wey bi di High Priest, kom with some eldas and one lawyer wey dem dey koll Tertullus and dem read wetin dem sey Paul do, give di govnor.
ACT 24:2 Wen dem orda make dem bring Paul kom out, Tertullus tell di govnor sey, “E don tey wen wi dey enjoy peace, bikos of how yu dey rule and all di betta-betta tins wey yu dey do take shange di kountry.
ACT 24:3 Oga God Felix, wi dey si all dis tins wey yu dey do for evriwhere. Na evriday wi dey tok about am and dey tank yu.
ACT 24:4 But make my story for nor long too mush, Abeg make yu hear us well-well as yu dey always do.
ACT 24:5 Bikos wi don si dis man sey e find trobol and kause wahala among all di Jew pipol for di world and naim dey lead di gang wey dem dey koll, ‘Di Nazarenes’.
ACT 24:6 E even take Greek pipol enter di temple, so wi kon arrest am.
ACT 24:7 But Lysias, di kommanding offisa kon take am komot from awa hand with force.
ACT 24:8 So wen yu ask am kweshon, yu go fit hear by yorsef all di tins wey wi sey e do.”
ACT 24:9 As e dey tok, di Jew pipol too dey support sey, wetin e tok, na true.
ACT 24:10 Wen di govnor sey make Paul tok, e kon sey, “I know sey yu don bi judge for dis kountry for many years naw, so I nor go fear dey tok as I dey defend mysef.
ACT 24:11 As yu go fit shek for yorsef, e neva pass twelf days naw wey I go Jerusalem go woship.
ACT 24:12 Dem nor si mi dey argue with anybody or dey gada crowd for di temple varanda or inside di sinagog or even for di whole town,
ACT 24:13 dem nor fit show yu di offence wey dem akuiz mi sey I kommit.
ACT 24:14 But I go let yu know sey I dey woship di God wey awa grand-grand papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na one kind gang). Dem bilive evritin wey di law tok and wey di profets rite down.
ACT 24:15 I get hope for God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipol wey don die, weda na bad or good pipol, go wake-up.
ACT 24:16 Na bikos of dis I dey always try my best to get klean belle for God and pipol front.
ACT 24:17 Afta many years, I kom Jerusalem back kon give gift to poor pipol and offa sakrifice.
ACT 24:18 Dis na wetin I dey do wen dem si mi for di temple; I dey klean and I nor gada any crowd or disturb anybody.
ACT 24:19 But some Jew from Asia suppose dey here dey tok di tin wey dem get against mi, if dem get anytin to tok at-all.
ACT 24:20 Or make dis men wey dey here tok di crime wey I kommit as I face di kansol,
ACT 24:21 bikos if e pass dis one, I go shaut as I stand for dia front sey, ‘Una dey judge mi today, bikos I bilive sey pipol wey don die, go wake-up.’ ”
ACT 24:22 Den Felix, wey bi sey e know di true story about di Way, pospone di kase kon sey, “Wen Lysias, di kommanding offisa kom, I go judge yor kase.”
ACT 24:23 E kon orda di soja oga make e guide Paul, but make e gi-am small freedom and make e nor drive en friends if dem won gi-am anytin.
ACT 24:24 Afta some days, wen Felix with en wife Drusilia wey bi Jew, sidan togeda, dem kon sey make dem bring Paul, so dat dem go listin to am, as e dey tok about how pesin go fit take bilive Jesus Christ.
ACT 24:25 Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”
ACT 24:26 Bikos e dey hope sey Paul go bribe am, naim make am sey make dem bring Paul kom meet am many times.
ACT 24:27 Afta two years, Porcius Festus take-ova from Felix and bikos Felix one make di Jew pipol happy, e kon leave Paul for prison.
ACT 25:1 Wen three days don pass, Festus komot from Caesaria go Jerusalem.
ACT 25:2 So di priest oga dem and all di big men among di Jew pipol kon tell am wetin dem sey Paul do.
ACT 25:3 Dem beg am make e give orda sey make dem bring Paul kom Jerusalem back, bikos dem plan to attack and kill-am for road.
ACT 25:4 Den Festus ansa, Paul dey for Caesaria and mi mysef go soon go der.
ACT 25:5 So e sey, “Make yor leaders follow mi go der and if dis man do anytin wey bad, make dem akuiz am.”
ACT 25:6 Festus nor stay rish eight or ten days wen e go Caesaria and di next day, e sidan for di judgement seat kon give orda sey make dem bring Paul kom.
ACT 25:7 Wen Paul rish der, di Jew pipol wey kom from Jerusalem kon stand round am, dey akuiz am sey e kommit sin wey dem nor fit show.
ACT 25:8 Paul defend ensef sey, “I nor kommit any offence against di Jew law or di temple or against Caesar.”
ACT 25:9 Bikos Festus one make di Jew pipol happy, e kon ask Paul, “Yu ready to go Jerusalem make I judge yor kase for der?”
ACT 25:10 Paul ansa, “I stand for Caesar judgement seat, na here dem go for judge my kase. I nor kommit any offence to Jew pipol and even yu yorsef know.
ACT 25:11 I nor do bad and I nor kommit any offence wey dem fit take kill mi, I nor dey try to run sey make dem nor kill mi, but if evritin wey dem tok against mi nor bi true, nobody go fit karry mi, give dem. I sey make dem karry my kase go give Caesar!”
ACT 25:12 Festus kon sey, “Yu don tok sey make Caesar judge yor kase, so, na Caesar yu go-go meet!”
ACT 25:13 Afta some days, King Agrippa and Bernice go Caesaria, go salot Festus.
ACT 25:14 As dem dey der for many days, Festus kon tell dem about Paul kase, so dat e go hear wetin dem go tok about di matter, so e koll Agrippa kon sey, “One man dey for here wey Felix leave for prison.
ACT 25:15 Wen I dey Jerusalem, di priest oga dem and di eldas kon tell mi about am sey make I kill-am.
ACT 25:16 But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’
ACT 25:17 So afta dem follow mi kom here, I kon pospone di kase, but di next day I sidan for judgement seat kon orda make dem bring di man kom.
ACT 25:18 Wen pipol wey dey akuiz am stand up, dem nor tok any bad tin against am as I bin suspet.
ACT 25:19 Instead, dem dey argue matter with am, about how dem dey serve God and one man wey dem dey koll Jesus Christ wey don die, wey Paul sey e still dey alive.
ACT 25:20 Bikos I nor know how I go take judge di matter, I kon ask am weda e go like go Jerusalem make dem judge am der.
ACT 25:21 But Paul sey make dem take am go Rome, so dat Caesar go judge en kase, so I kon orda sey make dem keep am for prison, until I go fit send am go meet Caesar.”
ACT 25:22 Agrippa kon tell Festus, “Mi too go like hear from di man.” So Festus tell am, “Yu go hear from di man tumoro.”
ACT 25:23 So di next day, Agrippa and Bernice kon dey make yanga enter di hall, with all di big men wey dey di town. Afta Festus don give orda, dem kon bring Paul.
ACT 25:24 Den Festus sey, “King Agrippa and all of una wey dey here with us, make una si dis man wey di whole Jew pipol dey beg mi both for here and for Jerusalem sey, make I kill.
ACT 25:25 But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar.
ACT 25:26 But I nor know wetin I go rite go give di emperor about am. So naim make mi bring am kom all of una and king Agrippa front, so dat afta una don kweshon am finish, I go get sometin wey I go fit rite.
ACT 25:27 Bikos for my mind, e nor dey rite to send prisona go kourt, wen yu nor rite wetin e do.”
ACT 26:1 So Agrippa tell Paul, “Make yu tok for yorsef naw.” Den Paul raiz en hand kon start to tok.
ACT 26:2 “King Agrippa, about all dis tins wey di Jew pipol dey akuiz mi sey I do, I tank God sey I won defend mysef give yu today,
ACT 26:3 bikos yu know all awa tradishon and di matter wey di Jew pipol dey akuiz mi about. So, Abeg, make yu listin to wetin I won tok.
ACT 26:4 Naw, all di Jew pipol know sey na from small pikin I dey live my life with my own pipol for Jerusalem.
ACT 26:5 Since dem know mi, if dem go gri kon tok, dem go gri sey na how wi dey serve God, naim I take live as Farisee.
ACT 26:6 Naw, I stand make dem judge mi, bikos I put hope for di promise wey God make give awa grand-grand papa dem
ACT 26:7 sey, awa twelf tribes go gain as dem dey use all dia mind dey serve God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim make di Jew pipol dey akuiz mi so!
ACT 26:8 Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?
ACT 26:9 Even mi mysef, I bilive before sey make wi fight Jesus Christ wey kom from Nazaret.
ACT 26:10 And na wetin I do for Jerusalem bi dat. Nor bi only sey I put many of di bilivers for prison with di pawa wey di priest oga dem give mi, but I even dey support wen dem sey make dem kill dem.
ACT 26:11 I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.
ACT 26:12 “But one day, as I dey do all dis tins, I kon dey go Damaskus with full pawa wey di priest oga dem give mi.
ACT 26:13 My king, around aftanoon for road, I kon si one kind lite from heaven wey shine pass di sun. Di lite shine round mi and di pipol wey dey follow mi travel.
ACT 26:14 Wen wi don fall for groun, I hear one vois wey use Aramaik language tell mi, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi? Yu dey fight yorsef, bikos na stone yu dey kick so.’
ACT 26:15 So I ask am, ‘Oga God! Who yu bi?’ God ansa, ‘I bi Jesus Christ wey yu dey ponish.
ACT 26:16 But make yu get up, bikos I don show mysef to yu and don choose yu as my savant and witness to di tins wey yu don si and di ones wey I go show yu.
ACT 26:17 I go save yu from yor own pipol and from Gentile pipol wey I dey send yu go meet, so dat
ACT 26:18 yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
ACT 26:19 “So King Agrippa, I nor do strong head wen I receive dis vishon wey kom from heaven,
ACT 26:20 but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.
ACT 26:21 Bikos of dis, di Jew pipol seize mi for di temple front, won kon kill mi.
ACT 26:22 But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,
ACT 26:23 sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”
ACT 26:24 As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!”
ACT 26:25 But Paul ansa am, “I nor dey mad oga Festus, but na betta word wey dey good naim I dey tok so.
ACT 26:26 Even di king wey I dey tok to so, I bilive sey e know about all dis tins, bikos dem nor happen for sekret.
ACT 26:27 King Agrippa! Yu bilive di tin wey di profets tok?”
ACT 26:28 Agrippa ask Paul, “So yu tink sey just naw-naw, yu fit turn mi to Christian?”
ACT 26:29 Paul ansa, “I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi only yu, but evribody wey dey here, go bi like mi, but make una nor sofa, as I dey sofa so.”
ACT 26:30 So di king, di govnor and Bernice kon get up
ACT 26:31 and as dem dey go, dem kon tell each oda, “Dis man nor do anytin wey go fit make dem kill-am or put am for prison.”
ACT 26:32 Agrippa kon tell Festus, “Wi for fit release dis man, if to sey e nor sey make Caesar judge en kase.”
ACT 27:1 Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group.
ACT 27:2 Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika, follow us.
ACT 27:3 Di next day, wi enter Sidon and Julius kon do good give Paul, e allow am go meet en friends make dem fit gi-am all di tins wey e nid.
ACT 27:4 From der, wi enter wota travel again face Cyprus island, bikos breeze dey blow di ship.
ACT 27:5 Afta wi don travel enter di open sea wey dey inside Silisia and Pamfilia, wi kon stop for Myra, wey dey Lycia.
ACT 27:6 For der, di soja kommander kon si one ship wey kom from Alexandria dey drive go Italy and e kon put us for inside.
ACT 27:7 Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus. Bikos di breeze nor make us fit go front again, wi kon drive small-small dey go Krete, wey dey opposite Salmone.
ACT 27:8 Before wi rish Krete wotaside, e hard us well-well and wi kon rish one place wey dem dey koll, “Fair Havens” wey dey near Lasea town.
ACT 27:9 As e bi sey time don go well-well and di journey don hard like dis, bikos di time wey dem dey fast don pass, Paul kon advise dem sey,
ACT 27:10 “My pipol, I dey si sey dis journey na with wahala e go take end and nor bi only di load and di ship go lost, but many pipol go die too.”
ACT 27:11 But di kommander nor listin to am and na wetin di kaptain and di ship owner tok, naim e bilive.
ACT 27:12 Bikos di place where ship dey pak put wen dem si, nor good for kold weda; some for di pipol kon gri sey make wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix, wey dey Krete, wey face sout-west and nort-west, so dat wi go fit spend kold sizin for der.
ACT 27:13 Wen one kind kwayet breeze blow kom from sout, dem tink sey dem go fit do wetin dem plan, so dem kon dey go small-small pass Krete wotaside.
ACT 27:14 Afta di kold breeze, one strong breeze wey dem dey koll, “Hurricane”, kon dey blow kom from di Island.
ACT 27:15 Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again, wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like.
ACT 27:16 As wi dey run go hide under one small island wey dem dey koll Kauda, nor bi small wahala, before wi fit kontrol di ship.
ACT 27:17 Afta dem don drag di ship komot from di wota, dem kon take rope tie am. Wi dey fear sey wi go run around for Sirtis, so wi hook di ship for groun kon leave di breeze make e karry us go.
ACT 27:18 Di next day, bikos di breeze worry us well-well, wi kon dey trow awa load put for wota
ACT 27:19 and wen di third day rish, dem use dia hand trow wetin dem take dey kontrol di ship put for wota.
ACT 27:20 Wen wi nor si sun or star for many days and di breeze still dey worry us, wi kon luz hope sey wi don die bi dat.
ACT 27:21 Afta dem don stay without food for many days, Paul stand for dia front kon sey, “My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala.
ACT 27:22 Naw, I won make una heart strong, bikos nobody go die among us, but na only di ship go skata.
ACT 27:23 Bikos yestiday nite, God wey I dey serve, en angel appear to mi
ACT 27:24 kon sey, ‘Make yu nor fear Paul! Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’
ACT 27:25 So, my pipol, make una heart strong, bikos I bilive sey na as God tell mi, na so e go bi.
ACT 27:26 But wi sure sey wi go rish land.”
ACT 27:27 Afta fourteen days, as di breeze dey karry us pass di Adriatik Sea for mid-nite, di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land.
ACT 27:28 Dem trow long rope wey dem tie sometin put inside di wota to measure how e deep rish and dem si sey di wota still deep rish 40 metres. Afta e don tey small, dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres.
ACT 27:29 Dem dey fear sey di ship go jam rock for di land, so dem trow for big-big shain from di ship back kon dey pray make day kwik break.
ACT 27:30 Den di sailor try to run leave di ship, dem take di small boat for di ship, put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big shain down for di ship front,
ACT 27:31 but Paul tell di offisa and sojas, “Unless all dis men stay inside di ship, all of us go die.”
ACT 27:32 So di sojas kon kut di rope for di boat make e float go.
ACT 27:33 As day one break, Paul enkourage dem make dem chop kon sey, “Today make am fourteen days wey una dey worry, sotey una nor gri chop.
ACT 27:34 So naw, I dey beg una to chop, bikos una nid am to survive. And nobody among una go luz even one hair for en head.”
ACT 27:35 Wen Paul tok finish, e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop.
ACT 27:36 All of dem get strong heart kon take food chop.
ACT 27:37 (Wi bi 276 wey dey inside di ship.)
ACT 27:38 Wen dem don chop beleful, dem kon trowey all di remainin bread inside di wota make di ship nor for heavy again.
ACT 27:39 Wen day break, dem nor know where dem dey, but dem si one small land wey near di sea and dem tok for dia mind sey, if e dey possibol dem go use di ship take enter di land.
ACT 27:40 So dem kut all di shains wey whole di ship kon let dem fall inside di sea. Dem still luz di ones wey dey whole wetin dey kontrol di ship. Dem let breeze blow di ship go front and wi kon move face land.
ACT 27:41 But dem meet san-san for di sea. So di ship front kon hook and e nor fit move again, di back skata, bikos of di way di wave dey blow am.
ACT 27:42 Di sojas kon plan to kill all di prisonas make dem nor for fit swim kon eskape.
ACT 27:43 But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land
ACT 27:44 and di rest pipol kon follow for back, some whole di wood and odas whole di ship body wey break. Na so all of dem take rish land and nobody die.
ACT 28:1 Afta wi don rish land and nobody die, wi kon hear sey, na Malta dem dey koll di island.
ACT 28:2 Di pipol wey dey stay for der trit us well. Dem make fire for us, bikos rain don start to dey fall and kold dey katch us.
ACT 28:3 Wen Paul dey gada plenty stik make e put inside di fire, one snake wey dem dey koll, “Vipa”, kom out bikos of di heat kon put e mout for Paul hand.
ACT 28:4 Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”
ACT 28:5 But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all.
ACT 28:6 But dem dey tink sey en body go swell-up or e go fall for groun die. So afta dem don wait for sometaim kon si sey nor-tin happen to am, dem kon shange mind sey, Paul na god.
ACT 28:7 Dat time for dat aria, Publius, wey bi di oga, get some land. E welkom us kon give us food for three days.
ACT 28:8 Publius papa kon get fever and en belle dey pain am. Paul go si am kon heal am.
ACT 28:9 Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.
ACT 28:10 Dem kon dey praiz us well-well and wen wi won go, dem give us evritin wey wi nid.
ACT 28:11 Afta wi don dey der for three monts, wi kon enter ship from Alexandria wey stop for di island for kold time and di sign wey dey di ship front, na “Twins god.”
ACT 28:12 Wi stop for Syrakuse kon stay der for three days.
ACT 28:13 From der wi kon rish Rhegium and afta one day, one kind breeze from sout kon start to dey blow and di sekond day, wi kon rish Puteoli.
ACT 28:14 For der, wi si some brodas and dem kon beg us to stay with dem for seven days. Na so wi take rish Rome.
ACT 28:15 Wen di brodas for Rome hear about us, dem waka until dem rish “Appius Forum” and di “Three Taverns” kom meet us. Wen Paul si dem, e tank God and di tin kon make en heart strong well-well.
ACT 28:16 Wen Paul enter Rome, dem allow am stay en own house with di sojas wey dey guide am.
ACT 28:17 Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.
ACT 28:18 Wen dem don kweshon mi, dem won release mi, bikos dem nor si anytin wey go make dem kill mi.
ACT 28:19 But wen di Jew pipol nor gri make dem free mi, di tin kon make mi sey, I won go Rome make Caesar for judge my kase, nor bi bikos I get anytin wey I dey komplain against my pipol.
ACT 28:20 Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.”
ACT 28:21 Di pipol ansa, “Dem nor send us any leta about yu from Judea and no one for awa brodas don kom from der kon sey yu dey do bad tins.
ACT 28:22 But wi go like to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi know sey evribody for di whole world dey take mout kondemn dis group wey yu dey inside.”
ACT 28:23 Dem kon gri for di day wen dem go meet am and dem plenty wey kom en house kon meet am. So, from morning till evening, Paul kon dey esplain tins give dem. E dey tok about God kingdom and dey try to show dem wetin Moses Law and di profets tok about Jesus Christ.
ACT 28:24 Some among dem bilive wetin e tok, but some nor bilive.
ACT 28:25 So dem kon go, but dem nor gri among demsef afta Paul sey, “Di word wey di Holy Spirit tok thru di Profet Isaya, na true
ACT 28:26 sey, “ ‘Una go meet and tell dis pipol sey, “Una go dey hear, but una nor go undastand, una go dey look, but una nor go fit si.
ACT 28:27 Una heart nor dey undastand and una ear nor dey hear well again. Devil don klose una eye, make una nor for fit si; hear with una ears or undastand with una heart, so dat una nor go fit turn kom meet God, make E for heal una.” ’
ACT 28:28 “So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”
ACT 28:29 Wen e tok finish, di Jew pipol kon leave der dey vex among demsef.
ACT 28:30 So for two full years, Paul stay der for en own house wey e rent and e welkom all di pipol wey kom meet am
ACT 28:31 kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.
ROM 1:1 Paul wey bi Jesus savant and apostle wey e choose make e prish God word, na en rite dis leta.
ROM 1:2 Na dis gospel God promise us for en Holy Book thru en profets sey,
ROM 1:3 my Pikin kom dis world from David family
ROM 1:4 and naim bi my only Pikin wey I wake-up from deat with di Holy Spirit pawa.
ROM 1:5 Na thru am, God give us favor and pawa to bi apostles and na dis pawa wi dey use take dey koll Gentile pipol, make dem obey and bilive en name.
ROM 1:6 Unasef dey among di pipol wey God koll to bi Jesus Christ own.
ROM 1:7 Rome pipol wey God love and koll make dem bi en own, na una I dey rite dis leta give. Make God awa Papa for heaven and Jesus awa Oga God give una grace and peace.
ROM 1:8 Today, I tank my God thru en pikin Jesus Christ for all of una, bikos na for di whole world dem dey tok about how una faith for God strong rish.
ROM 1:9 God wey I dey serve and prish en pikin gospel, na-im fit bear mi witness sey I always dey remember una
ROM 1:10 and I always dey pray dey ask God if E go let mi kom si una again.
ROM 1:11 Bikos I dey hongry to si una, so dat I go give una di Holy Spirit blessing wey go make una strong,
ROM 1:12 den mi and una go dey happy and Jesus Christ wey wi bilive, go give us rest for awa mind.
ROM 1:13 My brodas and sistas, I wont make una know sey I don plan to kom visit una many times, but God nor let mi kom until naw. Bikos I won gain from una faith as I don do with Gentile pipol.
ROM 1:14 Bikos God sey make I prish to evribody, weda na Greek or Gentile pipol or weda dem wise or foolish.
ROM 1:15 Na dis make mi won kom prish God word give una wey dey Rome.
ROM 1:16 I nor dey shame to prish God word, bikos na-im bi di pawa wey God take dey save doz wey bilive am, weda dem bi Jew or Gentile pipol.
ROM 1:17 Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”
ROM 1:18 Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey do, God vexnashon dey show from heaven and di sins dey kover di trut.
ROM 1:19 So God ponish dem, since dem know evritin wey dem suppose to know about God, bikos na-im show dem.
ROM 1:20 From di time wen God kreate di world, E don show us di tins wey ordinary eye nor dey fit si; E show us en pawa and life thru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuse at-all.
ROM 1:21 Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.
ROM 1:22 Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;
ROM 1:23 bikos instead make dem woship God wey dey heaven, dem kon dey woship image wey dem mold or karve like pesin, bird, animal or snake.
ROM 1:24 So God don leave wiked pipol make dem dey do di bad tins wey dia mind, wey bi sey man dey sleep with man and woman dey sleep with woman.
ROM 1:25 Dem don turn di trut about God to lie. Dem dey woship di tins wey E kreate, instead make dem serve God wey deserve all di praiz forever! Amen.
ROM 1:26 Bikos of dis, God leave dem for dia yeye life. Even di wimen shange and dem kon dey do tins wey nor good.
ROM 1:27 And na so too, men nor kon like wimen again, but dem kon dey like to sleep with oda men. So, God ponish dem bikos of wetin dem dey do.
ROM 1:28 Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.
ROM 1:29 Wetin full dia mind na wikedness, evil tins, long-trot, bad belle, bad-bad tins; jealousy, to kill and fight, to lie, to keep enemy with pipol, to judge pipol waka,
ROM 1:30 to tok bad about odas and hate God. Dem dey karry body up, dem nor get respet and na bad tins full dia mind. Dem nor dey respet dia papa and mama.
ROM 1:31 Dem nor get sense, dem dey promise and fail, dem nor dey do good or sorry for pipol.
ROM 1:32 Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.
ROM 2:1 Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.
ROM 2:2 Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins.
ROM 2:3 Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement?
ROM 2:4 May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am?
ROM 2:5 But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.
ROM 2:6 God go pay evry man akordin to wetin e do.
ROM 2:7 God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.
ROM 2:8 But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.
ROM 2:9 Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment.
ROM 2:10 But God go give glory, honor and peace to anybody wey dey do good, weda e bi Jew or Gentile,
ROM 2:11 bikos God go judge evribody di same way.
ROM 2:12 Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem.
ROM 2:13 Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.
ROM 2:14 Gentile pipol nor get di law, but dem dey use dia sense do wetin di law tok and dat one don turn law for dem, even doh dem nor know Moses Law.
ROM 2:15 Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.”
ROM 2:16 So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
ROM 2:17 Wot of yu wey sey yu bi Jew? Yu wey put yor hope for di law kon dey use God dey boast;
ROM 2:18 yu know wetin God wont make yu do and yu don learn how to do good tins, bikos yu know di law.
ROM 2:19 Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for darkness si lite,
ROM 2:20 and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law.
ROM 2:21 Yu wey dey tish odas, why yu nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey make pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif?
ROM 2:22 Yu wey sey make pipol nor kommit adultery, yu nor dey kommit adultery? Yu wey sey yu hate juju, yu nor dey take tins wey dem keep for juju house?
ROM 2:23 Yu wey dey take di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law!
ROM 2:24 Just as God word sey, “Bikos of una wey bi Jew pipol, Gentile pipol dey take God name make yeye.”
ROM 2:25 Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same.
ROM 2:26 So if Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go take dem as pipol wey dem sekonsaiz?
ROM 2:27 Yu nor know sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go judge yu wey bi Jew, since yu dey break di law?
ROM 2:28 Pesin nor bi Jew bikos of wetin pipol si from outside. Di really sekonsishon nor bi wetin pipol dey si,
ROM 2:29 but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
ROM 3:1 How Jew pipol take betta pass Gentile pipol sef? Or betta tin dey bikos dem sekonsaiz pesin?
ROM 3:2 E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message.
ROM 3:3 But wot if some for dem nor gri bilive? Dat mean sey God dey lie?
ROM 3:4 Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”
ROM 3:5 If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).
ROM 3:6 Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world?
ROM 3:7 If my lie-lie life dey show sey God word na trut, wetin go make am kondemn mi sey I bi sina?
ROM 3:8 Den e go dey rite if wi sey, “Make wi dey do bad tins so dat good tins go kom out from wetin wi dey do?” But some pipol dey lie for my head, bikos of wetin I tok and God go ponish dem.
ROM 3:9 So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.
ROM 3:10 Just as God word sey, “Nobody dey raitious.
ROM 3:11 Nobody dey wey wise or undastand God.
ROM 3:12 Evribody don turn leave God, all of dem don bi yeye for God eye. Nobody dey do wetin good at-all.
ROM 3:13 Na lie wey fit kill pesin full dia mout and wiked words full dia tongue.
ROM 3:14 Bad belle dey dia mind and na so-so swear dem dey swear.
ROM 3:15 Dem go fit kwik kill pesin.
ROM 3:16 Anywhere dem go, dem must fight skata di place
ROM 3:17 and dem nor know how to dey kwayet.
ROM 3:18 Dem nor dey fear God at-all.”
ROM 3:19 Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.
ROM 3:20 Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean.
ROM 3:21 Naw, God don show us how wi go take dey good for en eye and nor bi thru di law, even doh na so Moses Law and di profets tok.
ROM 3:22 Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin.
ROM 3:23 Evribody don sin and wi don fall komot from God glory,
ROM 3:24 but God don make us dey rite with am thru en free gift wey E give us, bikos of Jesus Christ wey save us.
ROM 3:25 Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins.
ROM 3:26 Dis still show sey God dey rite wen E asept pipol wey bilive Jesus Christ. E dey ponish sinnas, so dat wi go know sey en na God wey nor like sin. Like dis, God show sey en dey rite and anybody wey bilive Jesus Christ, E dey make dem dey rite too.
ROM 3:27 So, wetin make us dey boast? Wi nor fit boast at-all! Why e bi like dis? Na bikos wi dey obey di law? No! Na bikos wi bilive Jesus Christ.
ROM 3:28 So, na thru faith pesin go dey rite with God, nor bi as e obey di law rish.
ROM 3:29 Abi na only Jew pipol God dey dia side? E nor dey Gentile pipol side too? True-true, God dey Gentile pipol side.
ROM 3:30 Since na only one God dey, E dey for Jew and Gentile pipol, bikos of dia faith.
ROM 3:31 So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.
ROM 4:1 Na wetin Abraham awa grand-grand papa learn from dis matter?
ROM 4:2 If na di good tins wey e do make am dey good for God eye, den e suppose to dey boast for pipol, but e nor go ever fit boast for God.
ROM 4:3 Wetin dem rite for God word? “Abraham bilive God thru faith and God kon si am as raitious pesin.”
ROM 4:4 Wen pesin work, dem must pay am en money, nor bi dash e bi, but na money wey e work for.
ROM 4:5 Doz wey nor depend on wetin dem dey do, but dem get faith and bilive sey God dey forgive sinnas, na dis faith God dey use take forgive dem dia sins.
ROM 4:6 David tok di same tin wen e tok about di blessing wey pesin dey get wen God don asept am, even doh dem nor deserve dat kind blessing. David still sey,
ROM 4:7 “God don bless pipol wey E forgive kon take dia sins komot.
ROM 4:8 God don bless di pesin wey E don forgive en sins!”
ROM 4:9 Dis blessing wey David dey tok about so, na only Jew pipol e tok am for, bikos dem sekonsaiz dem? No! Na still for Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz. Bikos wi read for God word sey, “Abraham bilive God and bikos of en faith, God kon asept am as raitious pesin.”
ROM 4:10 Na wen all dis tins take happen? Na before dem sekonsaiz Abraham or afta dem sekonsaiz am? Na before, nor bi afta dem sekonsaiz am!
ROM 4:11 But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.
ROM 4:12 Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia faith bi like en own, afta dem sekonsaiz am.
ROM 4:13 Wen God promise Abraham and en shidren sey dem go inherit di whole world, E do am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, but bikos e bilive God and God si am as raitious pesin.
ROM 4:14 If God promise na for only doz wey dey obey di law, den faith nor mean anytin and God promise go dey yuzles.
ROM 4:15 Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.
ROM 4:16 Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.
ROM 4:17 God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.
ROM 4:18 Even wen tins hard, Abraham still bilive God and e hope sey God go do am, even wen e bi like sey nor-tin go happen. But naw, e don bikom, “Papa for many nashons.” Just as God tell am, “Yor shidren go many like di stars wey dey heaven.”
ROM 4:19 Abraham nor komplain for one day, even wen e don old nearly rish hundred years. Even doh E know sey en body don nearly die and en wife Sarah nor go fit born again,
ROM 4:20 e nor doubt God promise. En faith make am strong and e tank God for evritin.
ROM 4:21 E dey sure sey God go do wetin E promise.
ROM 4:22 Na dis make God koll am raitious pesin.
ROM 4:23 Even doh God koll am “Raitious pesin”, E tok dis word bikos of only Abraham?
ROM 4:24 No! E tok am for wi too wey God go still asept as raitious pipol; wi wey bilive sey God raiz Jesus Christ from deat.
ROM 4:25 Na awa sins make God give Jesus Christ to dem make dem kill-am and God raiz am from deat, so dat e go make us raitious pipol.
ROM 5:1 Since faith don make us dey good for God eye, wi don get peace thru awa Oga God Jesus Christ.
ROM 5:2 Na faith e take buy us so dat wi go enter God grace, di place where wi dey naw. So wi fit boast with God glory wey wi dey enjoy.
ROM 5:3 Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure,
ROM 5:4 and endurance dey bring good karata, wey go make us get hope.
ROM 5:5 Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en love like river wey dey flow inside awa heart, thru di Holy Spirit wey E give us.
ROM 5:6 For di time wen wi nor fit help awasef, Christ kon die for us wey bi sinnas.
ROM 5:7 Nobody go won die for anoda pesin wey dey good for God eye, aldo somebody go fit die for pesin wey good well-well.
ROM 5:8 But God show how en love for us big rish, wen E send Christ kom die for us, even doh wi still dey sin.
ROM 5:9 Naw, wi dey rite bikos of Christ blood and na dis blood go save us from God vexnashon.
ROM 5:10 Wi bi God enemies before, but E don make us en friends thru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God friends, E go save us thru di life wey en pikin get.
ROM 5:11 Nor bi only dis won make us dey happy, but wi still dey happy bikos of wetin God don do thru awa Oga God Jesus Christ wey make us bi God friends.
ROM 5:12 Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin.
ROM 5:13 Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin.
ROM 5:14 From Adam kon rish Moses time, na deat dey rule for dis world, even doh nor bi evribody disobey God kommand like Adam. Dis Adam bi like Christ wey kom leta.
ROM 5:15 But two of dem nor bi di same, bikos God free gift nor bi like Adam sin. Na true sey many pipol die bikos of one man sin. But God grace big well-well and e dey give free gift to pipol thru en pikin Jesus Christ!
ROM 5:16 God gift and one man sin nor bi di same. Judgement follow di one man sin kon kondemn evribody, but na God gift dey free us, even doh wi bi sinnas.
ROM 5:17 But if na bikos of one man sin deat kill evribody, den, doz wey don get favor and Christ gift, dey good for God eye and dem go enjoy life thru Jesus Christ!
ROM 5:18 God go ponish evribody bikos of Adam sin. But bikos of di good tins wey Jesus do, God don asept and give us di gift wey dey give life.
ROM 5:19 Bikos Adam nor obey God, many pipol bigin sin. But since Jesus obey God, many pipol go obey God too.
ROM 5:20 Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am
ROM 5:21 and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
ROM 6:1 So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us?
ROM 6:2 No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am?
ROM 6:3 Abi una nor know sey all di pipol wey dem baptize inside Christ don die with am?
ROM 6:4 Dem beri us with am wen wi baptize, so as God raiz Christ from deat thru en pawa with glory, na so wi too go get life wey nor dey end.
ROM 6:5 Bikos if wi don die with Jesus Christ thru baptizim, God go raiz us up with am.
ROM 6:6 Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.
ROM 6:7 Bikos pesin wey don die, don free from sin.
ROM 6:8 As wi die with Christ, wi bilive sey wi go live with am.
ROM 6:9 Wi know sey since God don raiz Christ up, e nor go die and deat nor get pawa for en body again.
ROM 6:10 Bikos as e die, e don ovakom sin forever, so di life wey e dey live naw, e dey live am for God.
ROM 6:11 So make una know sey, una don ovakom sin too and una get life thru Jesus Christ.
ROM 6:12 Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins.
ROM 6:13 Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
ROM 6:14 Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.
ROM 6:15 So na wetin wi go tok? Make wi still dey sin, bikos wi get God grace and wi nor dey under di law again? God forbid!
ROM 6:16 Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.
ROM 6:17 But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.
ROM 6:18 And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins.
ROM 6:19 (I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.
ROM 6:20 Bikos wen una bi sin savant, una nor nid to dey raitious.
ROM 6:21 So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.
ROM 6:22 But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.
ROM 6:23 Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.
ROM 7:1 My brodas and sistas, I know sey I dey tok to pipol wey know di law. Na only wen pesin still dey for life, naim di law dey get pawa for en body.
ROM 7:2 As di law tok, woman wey don marry dey under en husband as long as di man dey alive. But if di man die, di woman don free.
ROM 7:3 So if woman marry anoda man wen en husband still dey alive, e mean sey e don kommit adultery. But if en husband die, e don free from wetin di law tok and e go fit marry anoda man again.
ROM 7:4 So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.
ROM 7:5 Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.
ROM 7:6 But naw, wi don free from di law. Wi bi like deat body and di law nor get pawa for awa body again. Naw wi suppose to serve God with di new life wey di Spirit dey give, nor bi di old life, wey bi to obey di law wey pesin rite.
ROM 7:7 Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin.
ROM 7:8 But bikos of di law, di sin pawa wey dey inside mi kon dey make mi tink about tins wey nor good and if law nor dey, sin for nor get pawa for my life.
ROM 7:9 Before I know di law, I dey alive, but wen I hear God kommandment, sin just enter my life
ROM 7:10 and I kon die. So di law wey suppose give mi life, don kill mi!
ROM 7:11 Since sin pawa use di law deceive mi, I kon die.
ROM 7:12 But di law dey holy, rite and good.
ROM 7:13 So dis mean sey na wetin good kill mi? No! But na sin pawa wey dey inside mi, na-im kill mi; bikos e use wetin good bring deat and naw, wi dey si how sin bad and wiked rish.
ROM 7:14 Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.
ROM 7:15 I nor undastand wetin I dey do; bikos I nor dey do wetin I won really do. Instead na wetin I nor like, I dey do.
ROM 7:16 Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect.
ROM 7:17 Nor bi mi really dey do wetin I dey do, but na di sin pawa wey dey inside mi.
ROM 7:18 I know sey wetin dey inside mi nor go let mi do good. Even wen I won do good, I nor dey fit.
ROM 7:19 Instead of make I do wetin dey good, na bad tins I dey do.
ROM 7:20 So if I do wetin I nor won do, e show sey nor bi mi dey do am again, but na di sin pawa wey dey inside mi.
ROM 7:21 So I si sey dis law dey work, bikos wen I won do good, na only bad tins dey enter my mind.
ROM 7:22 I dey like to obey God law with my whole mind,
ROM 7:23 but inside mi, I kon undastand sey sometin dey fight against my mind and e dey make mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my body.
ROM 7:24 I nor dey happy at-all! Who go save mi from dis body wey dey push mi go die?
ROM 7:25 Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.
ROM 8:1 So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.
ROM 8:2 Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat.
ROM 8:3 Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
ROM 8:4 God do so, so dat wetin di law tok, go happen wen wi obey di Spirit, instead of awa own mind.
ROM 8:5 Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont.
ROM 8:6 If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.
ROM 8:7 Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
ROM 8:8 Doz wey dey obey sin, nor go fit make God happy.
ROM 8:9 But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live.
ROM 8:10 Christ dey live inside una. So una dey alive, bikos God don asept una, even doh una body must die, bikos of una sins.
ROM 8:11 If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
ROM 8:12 So my brodas and sistas, wi get work to do for God, so make wi nor live as awa body wont.
ROM 8:13 Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.
ROM 8:14 Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.
ROM 8:15 Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”
ROM 8:16 Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren.
ROM 8:17 And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
ROM 8:18 I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.
ROM 8:19 Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world.
ROM 8:20 Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope
ROM 8:21 sey one day, God go free dem from deat and wahala and dem go-go join en shidren wey E don save.
ROM 8:22 Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.
ROM 8:23 Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.
ROM 8:24 Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get?
ROM 8:25 But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient.
ROM 8:26 Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.
ROM 8:27 And God wey dey si evritin inside awa belle, know wetin dey di Spirit mind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
ROM 8:28 And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.
ROM 8:29 God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.
ROM 8:30 Doz wey God don asept, na dem E koll; doz wey E koll, na dem E make raitious and E kon share en glory with dem.
ROM 8:31 Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?
ROM 8:32 True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!
ROM 8:33 Who go fit akuiz pesin wey God don choose? Na God know who good or bad.
ROM 8:34 Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.
ROM 8:35 Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear?
ROM 8:36 As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.”
ROM 8:37 Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us!
ROM 8:38 But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom;
ROM 8:39 tins wey dey heaven; tins for under dis eart or anytin wey God kreate, non of dem go fit separate us from God love, bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
ROM 9:1 Na di trut I dey tok, na Jesus get mi and di Holy Spirit dey bear witness for my mind sey, I nor dey lie wen I sey,
ROM 9:2 e dey pain mi for mind and sorrow full my heart,
ROM 9:3 bikos I for like sey God go curse and separate mi from Christ, so dat my own flesh and blood,
ROM 9:4 wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.
ROM 9:5 Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.
ROM 9:6 Nor bi sey God promise don fail; bikos nor bi evribody wey dey Israel really bi God pipol.
ROM 9:7 And nor bi all Abraham pikin bi God shidren. Instead, God tell Abraham, “Na thru Isaak yu go get di shidren wey I promise yu.”
ROM 9:8 Dis mean sey di pikin wey Abraham born (Hagar pikin, Ishmael) before God promise am, nor bi di one wey God choose. Instead, di pikin wey e born thru God promise, na dat one bi Abraham true pikin.
ROM 9:9 Bikos na so God tok for en promise, “Wen di time don rish, I go kom back and Sarah go born boy.”
ROM 9:10 Nor bi only dat, bikos Rebekah shidren na one papa dem get and naim bi awa grand-grand papa, Isaak.
ROM 9:11 Even before dem born di shidren or sey dem do any bad or good tin, God tell Rebekah, “Di senior pikin go serve en junior broda, so dat my promise go stand:
ROM 9:12 nor bi bikos of wetin dem do, but na as I wont make e bi.”
ROM 9:13 Just as God word sey, “I love Jakob, but I hate Esau.”
ROM 9:14 Wetin wi go tok? Wi go sey God dey show parsha? No!
ROM 9:15 Bikos E tell Moses sey, “I go sorry for who I won sorry for and I go show mesi to who I like show mesi to.”
ROM 9:16 Derfor, evritin dey for God hand, nor bi by wetin pipol won do.
ROM 9:17 God tell Fero for en word sey, “I make yu king, so dat I go use yu show my pawa and pipol go fear my name for di whole world.”
ROM 9:18 So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.
ROM 9:19 I know sey yu go ask sey, “Wetin make God dey find fault for pipol body, since na-im make us dey do as wi dey do?”
ROM 9:20 But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”
ROM 9:21 Di man wey mold di pot fit use di klay as e like. E fit use di klay make two pot, one for big party and di oda one for house.
ROM 9:22 But God won show sey E dey vex, so E kon use en pawa against doz wey E won ponish.
ROM 9:23 E dey do like dis to show en glory wen E pity for pipol wey E choose to show en glory.
ROM 9:24 Weda wi bi Jew or Gentile pipol, E don choose us.
ROM 9:25 As E tok for Hosea book sey, “Doz wey nor bi my pipol before and di pipol wey nobody love before, I go koll dem, ‘Di pipol wey I love.’
ROM 9:26 For where God for tell dem sey, ‘Una nor bi my pipol, na der dem go for still koll dem “God shidren.” ’ ”
ROM 9:27 And dis na wetin Profet Isaya tok about Israel pipol, “Israel shidren many like san-san wey dey wotaside. But na few of dem, God go save.
ROM 9:28 Bikos God go kwik do wetin E sey E wont do for dis world, E go kom judge di world.”
ROM 9:29 Just as Profet Isaya tok before sey: “If to sey God Almighty nor save some among awa shidren, wi for don die finish like Sodom and Gomorrah.”
ROM 9:30 Wetin wi go tok? Even doh Gentile pipol nor dey raitious before, dem don dey raitious naw, bikos of faith.
ROM 9:31 And Israel pipol wey dey try to do wetin God wont, nor fit do am.
ROM 9:32 Why dem nor fit do am? Na bikos dem dey try to do good like sey na by work, nor bi with faith. Na dis make dem dey struggol kon dey fall on-top stone.
ROM 9:33 God word sey: “Si, for Zion, I dey arrange stones wey go make pipol fall, yet doz wey bilive am, E nor go disappoint dem.”
ROM 10:1 My brodas and sistas, I dey wish and pray to God from my heart evriday sey, make God save dem wey kom from Israel.
ROM 10:2 I know sey dem love God, but dem nor undastand am,
ROM 10:3 as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.
ROM 10:4 Since Jesus Christ kom, di law nor get pawa again and anybody wey bilive God, go dey raitious.
ROM 10:5 Na dis raitiousness wey di law tok, naim Moses rite about sey: “Di pesin wey follow di law must do evritin wey di law tok.”
ROM 10:6 But di raitiousness wey faith dey give pesin na sey: “Nor tok for yor mind sey, ‘Who go-go heaven go bring Jesus Christ kom down?
ROM 10:7 Or Who go-go bring Christ kom out from hell where dead body dey?’ ”
ROM 10:8 But wetin e tok? “God word dey near yu. Di word wey wi dey prish near yu, e get faith and e dey yor mout and heart.”
ROM 10:9 But if yu konfess with yor mout sey, “Jesus Christ na Oga God and yu bilive for yor heart sey, God raiz am from grave, yu go dey save.”
ROM 10:10 If yu bilive and prish with yor heart give pipol sey Jesus Christ na Oga God, God go save yu.
ROM 10:11 Bikos God word sey, “Anybody wey bilive am, nor go shame.”
ROM 10:12 Jew and Gentile pipol nor dey difren for God eye and E dey bless evribody wey dey pray to am,
ROM 10:13 bikos E go save doz wey dey koll en name.
ROM 10:14 How dem won take koll God make E help dem, wen dem nor bilive am? And how dem go fit bilive, wen dem neva hear about am? How dem go take hear about am, if nobody prish to dem?
ROM 10:15 How pesin go prish God word wen God nor send am? As God word sey, “Pipol wey dey prish di Good News dey waka well, bikos na good tins dem dey bring!”
ROM 10:16 But nor bi evribody gri asept di Good News, even Profet Isaya sey, “My God, anybody don bilive awa message?”
ROM 10:17 So, nobody go fit get faith wen e neva hear di message and na thru Christ word, wi go fit hear am.
ROM 10:18 But make I ask, dem neva hear di message before? Yes! Dem don hear am, bikos God word sey, “Dem prish di message and dia vois rish evriwhere for di world.”
ROM 10:19 I dey ask una again, “Israel pipol nor undastand?” Moses first tok sey, “I go use pipol wey nor bi anytin, so dat una go dey jealous dem. Na pipol wey nor get sense, na dem I go use take make una vex.”
ROM 10:20 And Profet Isaya even get strong heart to tell di pipol sey, “Pipol wey nor look for mi, na dem si mi. Doz wey nor ask for mi, na dem kon know mi well-well.”
ROM 10:21 But Profet Isaya still tok about Israel pipol sey, “I don dey koll dis my sturbon pipol, but dem nor dey hear word.”
ROM 11:1 I dey ask, God don rijet Israel, en pipol? No! Mi too, na Israel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe.
ROM 11:2 God nor rijet en pipol wey E choose from di biginnin. Dem rite for God word about how Elijah beg God for Israel pipol sey,
ROM 11:3 “Oga God, dem don kill all yor profets. Dem don skata yor altar, na only mi remain and dem dey try to kill mi too!”
ROM 11:4 Na wish ansa God gi-am? E tell am, “I still get 7,000 men wey neva woship Baal juju at-all.”
ROM 11:5 Na so e bi naw too, some Israel pipol still dey woship God bikos of en grace.
ROM 11:6 If na by grace God choose dem, dat mean sey, nor bi by pesin pawa: Bikos if na by pesin pawa, den grace nor mean anytin again.
ROM 11:7 Dis mean sey, na only few pipol for Israel fit get wetin all of dem dey find. Di rest nor gri listin to God, bikos of dia sturbones,
ROM 11:8 just as God word sey: “God make dem foolish sotey dia eye nor dey si and dia ear nor dey hear till today.”
ROM 11:9 But David sey: “Make di food wey dem dey chop, kause trobol for dem kon fall like stone for dia head and make God ponish dem.
ROM 11:10 Make dia eye blind, so dat dem nor go fit si. Make wahala bend dia back forever.”
ROM 11:11 I dey ask again, Israel pipol wey fall nor go get up again? No! But bikos of dia sins, Gentile pipol don get salvashon and dis tin, dey make Israel pipol jealous.
ROM 11:12 If Israel pipol sin fit make Gentile pipol dey save, dat mean sey, wen Israel pipol turn go meet God, pipol wey go dey save, go plenty well-well.
ROM 11:13 Naw, I dey tok to una wey bi Gentile pipol and as long as I bi una apostle, I dey happy with di work wey I dey do,
ROM 11:14 so dat my pipol go dey jealous, bikos of wetin God dey do for Gentile pipol. Dis go make dem turn from sin kom meet God and E go save dem.
ROM 11:15 Bikos wen God rijet Israel pipol, di whole world kon get salvashon. Na how e go kon bi, wen God asept dem back? E go give life to pipol wey won die.
ROM 11:16 If dem give God di first part for bread, den na God get all di bread and if dem give God tree rut, den di whole tree don bi en own too.
ROM 11:17 Gentile pipol, una bi like branches wey dem add join olive tree. Una don take di place for some branches wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessings, wey di rut dey give.
ROM 11:18 So make una nor boast, but make una remember sey, nor bi una dey make di rut stand, but na di rut dey support una.
ROM 11:19 So una go sey, “God break di branches komot, make E for fit si place wey E go put us.”
ROM 11:20 True-true, God break Israel pipol komot from di tree, bikos dem nor bilive am. But una dey where una dey, bikos una get faith. So, make una nor dey boast, instead, make una dey fear wetin God fit do.
ROM 11:21 If God nor sorry for Israel pipol wey bi di natural branches, una tink sey E go sorry for una if una sin?
ROM 11:22 Naw, una don si how God dey good and harsh. Even doh E dey vex for doz wey fall, E still dey kind to una. And E go always dey kind to una, as long as una dey do wetin E wont. If not, E go rijet una too.
ROM 11:23 If Israel pipol turn back kon meet God, E go put dem back for di tree, bikos E get pawa to do am.
ROM 11:24 Una wey bi Gentile pipol bi like olive tree branches wey dem kut for bush kon go put for anoda betta olive tree (and e nor suppose bi like dat). Na Jew pipol bi di betta olive tree; so e go eazy for God to join dem back to di original tree again.
ROM 11:25 My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.
ROM 11:26 Na so God go save all Israel pipol just as en word sey: “Di pesin wey go save Israel pipol go kom from Zion, den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.
ROM 11:27 And na dis go bi my agriment with dem wen I don forgive dem dia sins.”
ROM 11:28 As e bi sey Jew pipol rijet God word, dem don turn to God enemy, bikos of una wey bi Gentile pipol. But as God wont am, dem bi pipol wey E love, bikos of dia grand-grand papa dem.
ROM 11:29 God nor dey take back wetin e don already give pipol or shange en mind about di pipol wey E don choose.
ROM 11:30 As for una wey bi Gentile pipol, una don disobey God before, but naw, God don sorry for una, bikos Jew pipol nor gri obey am.
ROM 11:31 Bikos God don sorry for una, E go still sorry for dem too.
ROM 11:32 God trit evribody as prisonas, bikos wi nor gri do wetin E tell us. But E do am like dat, so dat E go fit sorry for all of us.
ROM 11:33 Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
ROM 11:34 Na who know wetin dey God mind? Who go fit advise God?
ROM 11:35 Wish pesin don borrow God sometin kon sey God go pay am back?
ROM 11:36 Bikos na God kreate evritin and na thru am evritin dey. Make praiz bi en own forever and ever! Amen.
ROM 12:1 My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
ROM 12:2 Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
ROM 12:3 By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.
ROM 12:4 Pesin body get difren parts and all di parts get dia own work.
ROM 12:5 Na so e bi with us. Wi many, but wi bi difren parts for Christ body and wi bilong to each oda.
ROM 12:6 True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get.
ROM 12:7 If wi dey serve odas, make wi serve dem well. If wi dey tish, make wi tish well.
ROM 12:8 If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.
ROM 12:9 Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
ROM 12:10 Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.
ROM 12:11 Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.
ROM 12:12 Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.
ROM 12:13 Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
ROM 12:14 Make una nor curse pipol wey dey opress una, but make una pray make God bless dem.
ROM 12:15 Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
ROM 12:16 Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.
ROM 12:17 Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye
ROM 12:18 and make una try to live for peace with evribody.
ROM 12:19 Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”
ROM 12:20 God word still sey, “If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop, if en troat dry, make yu gi-am wota drink, bikos as una dey do so, na wahala una dey karry put for en head.”
ROM 12:21 So, make una nor let bad tins kontrol una, but make una let di good tins wey una dey do, plenty pass wikedness.
ROM 13:1 Make evribody obey di pipol wey dey rule dem. Bikos na only God dey give authority and put pipol for pawa.
ROM 13:2 So anybody wey dey disobey dia ruler, dey disobey God and God go ponish am.
ROM 13:3 Bikos doz wey dey do good, nor go get problem with dia rulers, so dem nor nid to fear. Make una just do wetin dey good and dem go praiz una.
ROM 13:4 Bikos all rulers na God savant and na dia duty to help una. If una do bad, den make una fear, bikos dis rulers get pawa to ponish una. Dem bi God savants wey dey ponish doz wey do bad tins.
ROM 13:5 But una must obey di rulers, bikos una know sey naim bi di rite tin to do, nor bi bikos God go vex for una.
ROM 13:6 Una must still pay una tax too. Di rulers na God savants and na dia work to kare for all dis matter.
ROM 13:7 Make una pay evritin wey una dey whole; weda na tax, respet or honor.
ROM 13:8 Make love bi di only tin wey yu dey whole! If yu love odas, yu don do evritin wey di law tok.
ROM 13:9 Di law get difren-difren kommand like, “Nor kommit adultery; nor kill pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propaty.” All dis na just one kommand wey sey, “Make pipol love odas, just as dem love diasef.”
ROM 13:10 If yu love pesin, yu nor go do am bad. So, na love bi di main tin wey di law dey tok about.
ROM 13:11 Since una know di time wey wi dey naw, make una dey bihave well, bikos di time don rish wen una go wake-up from sleep. Una know sey di day wey God go give us salvashon, don near well-well pass as e bi wen wi first bilive.
ROM 13:12 Nite don nearly finish and day go soon break. So make wi stop to bihave like pipol wey dey darkness and make wi ready to waka for lite.
ROM 13:13 So make wi dey bihave well as pipol dey do for day time. Nor go anyhow party or drink too mush, den kon dey bihave anyhow. Nor kworel or judge pipol.
ROM 13:14 Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.
ROM 14:1 Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad.
ROM 14:2 Some pipol tink sey e dey rite to chop any food and odas wey dia faith dey weak, dey chop only vegitabol.
ROM 14:3 Since God dey welkom evribody, make una nor kondemn odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una like.
ROM 14:4 Wish rite yu get to kondemn anoda pesin savant? Na only dia oga fit tok weda dem dey do well and e must make sure sey, dem do di rite tin.
ROM 14:5 Some pipol tink sey one day betta pass anoda and some tink sey, evriday na di same. But make evribody bilive wetin dem won bilive.
ROM 14:6 Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.
ROM 14:7 Nobody dey live or die for ensef. Weda wi die or wi live, na God still get us.
ROM 14:8 If wi live, na God wi dey live for; if wi die, na God wi still die for. So, weda wi die or wi live, na God still get us.
ROM 14:9 Dis na bikos Christ die and e kom back to life, so dat e go bi Oga God to pipol wey don die and doz wey dey alive.
ROM 14:10 But why yu dey kondemn oda Christians? Why yu dey si dem as small shidren? Di day dey kom wen God go judge all of us.
ROM 14:11 God word sey, “Weda dem like am or not, evribody go knee down for my front kon sey na mi bi God.”
ROM 14:12 So, all of us go tell God wetin wi do with awa life.
ROM 14:13 So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith.
ROM 14:14 As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.
ROM 14:15 Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.
ROM 14:16 Nor let pipol curse Jesus Christ, bikos of di food wey yu dey chop.
ROM 14:17 Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.
ROM 14:18 If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.
ROM 14:19 So, make wi live for peace, den wi go help each oda grow as dem dey serve God.
ROM 14:20 Nor skata God work bikos of food. Evry food dey okay, but e nor good make yu chop wetin go spoil anoda pesin faith.
ROM 14:21 E betta make yu nor chop meat, drink wine or do anytin wey fit spoil yor brodas faith.
ROM 14:22 Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.
ROM 14:23 But if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondemn yorsef and yu know sey dat nor good, bikos anytin wey yu do against wetin yu bilive, na sin.
ROM 15:1 If awa faith dey strong, den make wi dey patient with doz wey get weak faith. Make wi try to make dem happy, instead of awasef.
ROM 15:2 Make wi tink of tins wey good for dem, den do wetin go make dem grow.
ROM 15:3 Even Christ nor do tins wey go just make ensef happy, but just as dem rite for God word, “Di pesin wey curse yu, don curse mi.”
ROM 15:4 Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.
ROM 15:5 So, I pray sey, God wey dey give konfort and patient, go help una live for peace with one anoda as una dey follow Jesus Christ,
ROM 15:6 so dat as una dey togeda, una go fit use one vois praiz God, wey bi awa Oga God Jesus Christ, Papa.
ROM 15:7 So make una asept one anoda just as Christ asept una, so dat God go get all di glory.
ROM 15:8 Make I tell una di trut, Christ kom as Jew pipol savant to show sey, God don keep di promise wey E make with dia grand-grand papa dem. Christ still kom,
ROM 15:9 so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”
ROM 15:10 God word still sey, “Gentile pipol! Make una happy with God pipol.”
ROM 15:11 Dem rite am for God word sey, “Una wey bi Gentile pipol, make una praiz God. Make evribody praiz am.”
ROM 15:12 Profet Isaya sey, “Somebody dey kom from David family (Jesse rut). E go rule Gentile pipol and dem go bilive am.”
ROM 15:13 I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.
ROM 15:14 My friends, I dey sure sey una dey good; know God well-well and fit tish one anoda.
ROM 15:15 But for dis leta, I rite some tins with boldness, so dat una go remember dem well-well. God dey good to mi and
ROM 15:16 naim make am choose mi to bi Jesus Christ savant for Gentile pipol and make I for dey prish di Good News. Dis tin happen, so dat di Holy Spirit go make God dey happy with Gentile pipol.
ROM 15:17 So I dey boast about di tins wey I dey do, bikos of Jesus Christ.
ROM 15:18 With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am.
ROM 15:19 Yes! I go tok how Christ take do many mirakles and wonders thru di Holy Spirit pawa. I don prish di Good News from Jerusalem go rish Illyricum.
ROM 15:20 But I like to prish di Good News for where pipol nor know Christ, so dat I nor go build house on-top anoda man foundashon,
ROM 15:21 just as God word sey, “Doz wey dem tell about am, go si am and doz wey neva hear about am, dem go undastand.”
ROM 15:22 My work neva let mi kom si una.
ROM 15:23 But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.
ROM 15:24 I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di journey, afta I don stay with una for sometaim.
ROM 15:25 But naw, I dey take message go give God pipol for Jerusalem,
ROM 15:26 bikos God pipol for Masidonia and Akaia give mi money make I give di poor Christians for der.
ROM 15:27 Dis na wetin dem really won do. Bikos wen den share di tins wey dem get with Jew pipol, den dem don follow Jew pipol share dia spiritual blessings too.
ROM 15:28 So, afta I don finish dis work kon dey sure sey di bilivers don get dia blessings for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain.
ROM 15:29 And I know sey wen I kom visit una, I go bring plenty blessings from Christ kon give una.
ROM 15:30 My brodas and sistas, I dey beg una with Jesus Christ and di Holy Spirit love; make una help mi pray to God.
ROM 15:31 Make una pray make God save mi from pipol wey nor bilive am for Judea and make di bilivers wey dey Jerusalem, asept wetin I dey prish.
ROM 15:32 Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
ROM 15:33 So make God wey dey give peace, dey with all of una. Amen.
ROM 16:1 I get betta tins to tok about awa sista, Foebe, wey bi leader for di church wey dey Cenchrea.
ROM 16:2 Make una welkom am with God name as God shidren suppose do. And make una gi-am anytin wey e nid; bikos e don help mi and oda pipol before.
ROM 16:3 Make una salot Priscilla and Akwila for mi. Dem bi my ko-workers for awa Oga God Jesus Christ work,
ROM 16:4 dem don even risk dia life bikos of mi. So, mi and di whole church dey tank dem well-well.
ROM 16:5 Make una still help mi salot di pipol for di church wey dey meet for dia house. Salot Epaenetus, my good friend (di first pesin to bilive Christ for Asia).
ROM 16:6 Greet Mary wey don work well-well with una.
ROM 16:7 Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ.
ROM 16:8 Greet Ampliatus, wey get faith and e bi my good friend.
ROM 16:9 Greet Urbanus wey follow us work. Greet Stachys wey bi my good friend.
ROM 16:10 Make una greet Apelles for mi, bikos Jesus Christ don choose am. Den make una still greet Aristobulus family for mi.
ROM 16:11 Make una greet Herodion my kountry man and Narcissus and en family wey don bilive God.
ROM 16:12 Greet Trifena and Trifosa and my friend Persis wey dey do Christ work.
ROM 16:13 Greet Rufus, di pesin wey di Oga God don choose and en mama wey trit mi like sey e bi my mama.
ROM 16:14 Make una greet Asynkritus, Flegon, Hermes, Patrobas, Hermas and all di brodas and sistas wey dey with dem.
ROM 16:15 Greet Filologus and Julia, Nereus and en sista, Olympas and all di bilivers wey dey with dem.
ROM 16:16 Make una salot one anoda with kiss for jaw. All di church wey bi Christ own, dey greet una.
ROM 16:17 Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!
ROM 16:18 Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
ROM 16:19 I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.
ROM 16:20 And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
ROM 16:21 Timoti, my ko-worker; Lucius, Jason and Sosipater my kountry man, all of dem dey greet una.
ROM 16:22 Even mi, Tertius wey rite dis leta, dey greet una with Christ name.
ROM 16:23 Gaius, wey dey kare for mi and di church, dey greet una. Erastus wey bi di town treasurer and awa broda Kwartus, dey greet una.
ROM 16:24 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una!
ROM 16:25 Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,
ROM 16:26 but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith.
ROM 16:27 Naw, wi dey praiz di only God wey dey wise forever, bikos of Jesus Christ! Amen.
1CO 1:1 Na Paul, wey God koll to bi Jesus Christ apostle and Sostenes, awa broda, na dem rite dis leta.
1CO 1:2 To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.
1CO 1:3 Make grace and peace wey God and Oga God Jesus Christ dey give, bi una own.
1CO 1:4 I dey always tank God, bikos of di grace wey E give una thru Jesus Christ.
1CO 1:5 Bikos wi dey with Christ, God make us dey rish for evry side, both for wisdom and undastandin,
1CO 1:6 bikos di message about Christ dey inside us,
1CO 1:7 so una nor go miss any gift wey di Holy Spirit dey give, as una dey wait for di day wen God go bring awa Oga God Jesus Christ kom back.
1CO 1:8 God go help una rish di end, so dat E nor go si fault for una life for di day wen Jesus go kom back.
1CO 1:9 God dey faithful, bikos na-im koll una to waka with en pikin, Jesus Christ wey bi awa Oga God.
1CO 1:10 My brodas and sistas, I dey beg una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor kworel, but make una get one mind for evritin wey una dey do.
1CO 1:11 Bikos I don hear thru Khloe family sey, una dey kworel among unasef.
1CO 1:12 Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”
1CO 1:13 Una hear sey dem divide Christ? Na Paul dem hang kill for cross? Abi na Paul name dem take baptize una?
1CO 1:14 I tank God sey I nor baptize any of una escept Krispus and Gaius,
1CO 1:15 so nobody go fit sey na my name dem take baptize am.
1CO 1:16 (I remember sey I still baptize Stefanas family. Apart from dem, I nor remember any oda pesin wey I baptize.)
1CO 1:17 Bikos Christ nor send mi go baptize, but na to prish di gospel and nor bi with ordinary wisdom wey go make di sofa wey Christ sofa for cross, yeye.
1CO 1:18 Di message about Christ deat for cross bi like foolish matter to pipol wey don lost, but for wi wey God don save, di message na God pawa.
1CO 1:19 Bikos God word sey, “I go distroy di wisdom wey wise pipol feel sey dem get. I go konfuse doz wey tink sey dem know too mush.”
1CO 1:20 Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
1CO 1:21 God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
1CO 1:22 Jew pipol won si mirakle before dem go bilive and Greek pipol, na wisdom dem won hear,
1CO 1:23 but di true message about Jesus wey dem kill for cross, naim wi dey prish and di message bi like stone wey Jew pipol kick by mistake kon fall, but to Gentile pipol, na yeye tin e bi.
1CO 1:24 But for wi wey God don koll, weda wi bi Jew or Greek; na Christ bi God pawa and wisdom wey save us.
1CO 1:25 Bikos God foolishness wise pass all di sense wey human being get and God weakness strong pass all di pawa wey dem get.
1CO 1:26 My brodas and sistas, make una remember how God koll una, nor bi bikos una wise, strong or get money well-well.
1CO 1:27 But God choose wetin di world tink sey dey foolish and weak, so dat wise and strong pipol go shame.
1CO 1:28 Wetin di world tink sey nor good, naim God choose; tins wey dem tink sey nor mean anytin, na doz tins E make important.
1CO 1:29 God do like dis, so dat nobody go fit boast for en front.
1CO 1:30 Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
1CO 1:31 bikos, God word sey, “Anybody wey won boast, make e use Christ take boast.”
1CO 2:1 My brodas and sistas, wen I kom tell una about God word, I nor tok to una with big-big word or try to show sey I get sense.
1CO 2:2 Bikos wen I dey with una, I plan sey, Christ wey dem kill for cross, na only en message I go tok to una about.
1CO 2:3 So wen I kom meet una, I dey weak and dey fear.
1CO 2:4 Wen I dey tok and prish to una, I nor try to show sey I get sense, but I dey do evritin with God pawa wey di Holy Spirit dey give,
1CO 2:5 so dat una faith go dey for God pawa, nor bi human being wisdom.
1CO 2:6 Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin.
1CO 2:7 Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.
1CO 2:8 No ruler for dis world fit undastand God wisdom, bikos if to sey dem fit, dem for nor nail and kill Christ wey get glory.
1CO 2:9 But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”
1CO 2:10 God show us dis tins thru en Spirit, bikos di Spirit dey find evritin; even di deep tins wey dey God mind.
1CO 2:11 Na only pesin spirit know wetin dey di pesin mind and na only God Spirit know wetin dey God mind.
1CO 2:12 God give us en Spirit, so wi nor dey tink as dis world pipol dey tink and naim make us know di blessings wey God don give us.
1CO 2:13 Evry word wey wi dey tok, na God Spirit tish us and nor bi human wisdom. Na dis same Spirit dey help us tish spiritual tins to pipol wey get God Spirit.
1CO 2:14 So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok.
1CO 2:15 Pesin wey dey listin to di Spirit fit judge oda pipol, but nobody go fit judge dem:
1CO 2:16 bikos God word sey, “Who fit know wetin God dey tink so dat e go advise am?” But wi wey get di Spirit, undastand wetin Christ dey tish.
1CO 3:1 My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own.
1CO 3:2 So I dey feed una with milk like small pikin and as e bi naw, una neva still fit chop strong food,
1CO 3:3 bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.
1CO 3:4 Some of una dey sey, “Na Paul I dey follow,” odas sey, “Na Apollos bi awa leader.” Na pipol wey nor know God dey do like dat!
1CO 3:5 Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.
1CO 3:6 I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.
1CO 3:7 Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.
1CO 3:8 Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.
1CO 3:9 All of us na ko-workers for God and na una bi God farm and en buildings.
1CO 3:10 Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,
1CO 3:11 bikos God don choose Jesus Christ as di One and only foundashon and dem nor go fit lay any oda foundashon.
1CO 3:12 So if anybody use gold, silva, fine stones, wood, or difren grass take build on-top dis foundashon,
1CO 3:13 make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do.
1CO 3:14 God go reward us if di fire nor burn wetin wi build.
1CO 3:15 But if di fire distroy am, wi nor go get anytin. But wi go dey save like pesin wey dem drag komot from inside fire.
1CO 3:16 Una nor know sey una bi God Temple and en Spirit dey inside una?
1CO 3:17 So If anybody distroy God Temple, God go distroy dat pesin too, bikos God Temple dey holy and na una bi dat temple.
1CO 3:18 Make una nor let anybody deceive una. If anybody tink sey e get sense for dis life, make e turn to fool, so dat e go really get sense.
1CO 3:19 Dis world wisdom, na foolishness for God present. Bikos God word sey, “God dey ponish pipol wey tink sey dem wise.”
1CO 3:20 God know sey na yeye tins wise pipol dey tink,
1CO 3:21 so, make wi stop to dey boast about wetin pesin do. Bikos both
1CO 3:22 Paul, Apollos, Pita, di world, life or deat; tins wey dey naw or tins wey go dey tumoro, all of dem na una own.
1CO 3:23 So una bi Christ own, just as Christ bi God own.
1CO 4:1 Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret.
1CO 4:2 God wont make wi dey faithful to am.
1CO 4:3 So, e nor koncern mi if yu or any human kourt dey judge mi. Even mi nor fit judge mysef.
1CO 4:4 My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.
1CO 4:5 So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
1CO 4:6 My friends, I don use mysef and Apollos as ezample for una, so dat thru us, una go know wetin e mean to obey di law. I nor wont make una dey sey one of us betta pass di oda pesin.
1CO 4:7 Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?
1CO 4:8 Una don really get evritin wey una nid! Una don get plenty money! Una don turn king with us! How I wish sey una really bi king, so dat wi go dey rule with una.
1CO 4:9 Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye.
1CO 4:10 Bikos of Christ, pipol dey si us as fools, but God don make us wise. Wi weak and dem hate us, but dem dey respet una wey dey strong.
1CO 4:11 Even today, wi dey hongry for food and wota, na only rag wi get to wear. Dem dey trit us anyhow and wi nor get house to stay.
1CO 4:12 Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient.
1CO 4:13 Wen pesin curse us, wi nor dey ansa back with kworel. So till today, dem dey si us as dirty for dis world.
1CO 4:14 I nor dey rite dis tins make una for shame, but na to korrect una as shidren wey I love.
1CO 4:15 Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.
1CO 4:16 So, I dey enkourage una sey, make una bi like mi.
1CO 4:17 Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.
1CO 4:18 Some among una don dey karry body up, bikos una tink sey I nor go kom back again.
1CO 4:19 But if God allow mi, I go soon kom meet una. Den I go know if pipol wey dey boast, really get pawa.
1CO 4:20 Bikos God kingdom matter, nor bi about ordinary tok, but na about pawa.
1CO 4:21 Wish one una wont? Make I karry kane kom meet una, or make I kon show una di love wey di Spirit dey give pesin?
1CO 5:1 I don dey hear bad-bad tins about some of una. And una own even worse pass wetin doz wey nor know God dey do. Sotey man dey sleep with en papa wife.
1CO 5:2 And shame nor even dey katch una! Una suppose to feel bad kon drive di pesin wey do dis kind tin.
1CO 5:3 I know sey I nor dey der with una naw, but I dey with una for spirit. And I don already judge di pesin, just as I go do if I dey der.
1CO 5:4 Wen una gada togeda for awa Oga God Jesus Christ name, I dey with una for spirit and Christ pawa dey with una too.
1CO 5:5 So make una give dat pesin to Satan make e ponish am, so dat en sin go komot for en body and Christ go save am for di last day.
1CO 5:6 E nor good make una dey boast! Una nor know sey, small yist wey dem put for bread, na-im dey make di whole bread raiz?
1CO 5:7 Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice.
1CO 5:8 So wen wi dey celebrate Passova, make wi nor do am with di old yist wey bi wikedness and bad belle, but make wi do am with di fresh bread wey nor get yist, wey bi trut and betta mind.
1CO 5:9 For di leta wey I first rite give una, I sey make una nor make friend with bad pipol.
1CO 5:10 But I nor dey tok about pipol wey bad, wiked, dey serve juju and get long-trot for dis world. If to sey na dem I dey tok about, den una nid to komot for dis world.
1CO 5:11 But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.
1CO 5:12 Wetin go make mi judge pipol wey nor dey di church? Nor bi doz wey dey inside wi suppose to judge?
1CO 5:13 Na God go judge doz wey dey outside, bikos en word sey, “Doz wey dey do wiked tins among una, make una drive dem komot from di church.”
1CO 6:1 Wen pesin nor dey gri with anoda pesin, una dey take una kase go kourt where sinnas go judge di matter, abi una dey take am go meet God pipol?
1CO 6:2 Una nor know sey na God pipol go judge di world? And if na una go judge di world, una nor fit setol small-small matter among unasef?
1CO 6:3 Una nor know sey wi go judge angels? Since na so, den wi suppose to judge di tins wey dey dis world!
1CO 6:4 So, na wetin make us dey take awa kase go give judge wey nor know God?
1CO 6:5 I dey tok like dis, so dat una go shame! So una nor get wise pesin among una wey fit judge between una wey bi Christians?
1CO 6:6 Wetin dey make una karry unasef go meet judge wey nor know God?
1CO 6:7 Wen una take unasef go kourt, dat mean sey all of una don luz.
1CO 6:8 Instead, una dey play wayo among unasef!
1CO 6:9 Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
1CO 6:10 tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.
1CO 6:11 Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.
1CO 6:12 Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.
1CO 6:13 Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.
1CO 6:14 God go raiz us from deat with di same pawa wey E use take raiz Jesus.
1CO 6:15 Una nor know sey una body na part for Christ body? So e dey good make wi put awa body for ashawo work? God forbid!
1CO 6:16 Una nor know sey, pesin wey dey sleep anyhow with oda pipol, don bi part for di pipol body?
1CO 6:17 So anybody wey join Christ, don get one spirit with am.
1CO 6:18 Make una nor live ashawo life. Evry oda sin wey man dey kommit na for outside en body, but di pesin wey dey do ashawo, dey sin against en own body.
1CO 6:19 Abi una nor know sey una body na di temple wey di Holy Spirit dey stay? So, nor bi una get unasef.
1CO 6:20 God don pay betta prize for una, so make una honor am with una body.
1CO 7:1 Naw I go ansa di kweshon wey una ask for una leta. Una ask sey, “E dey good make pesin nor marry?”
1CO 7:2 But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.
1CO 7:3 Make husband and wife do di rite tin wey dem suppose do for one anoda.
1CO 7:4 Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body.
1CO 7:5 Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.
1CO 7:6 Na advise I dey give una, nor bi kommand.
1CO 7:7 How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.
1CO 7:8 Dis na di advise wey I go tell di pesin wey neva marry and doz wey dia husband or wife don die; make una dey as una dey, just as I bi.
1CO 7:9 But if dem nor fit kontrol demsef, make dem marry, bikos e betta make pesin marry, dan make e dey tink bad tin for en mind.
1CO 7:10 Na doz wey don marry I won give dis kommand to (Nor bi mi, but na God): Make wife nor leave en husband,
1CO 7:11 but if e leave am, make e nor marry again or make e go back go setol with di man. And make husband nor leave en wife too.
1CO 7:12 Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am.
1CO 7:13 If yor husband nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor run leave am.
1CO 7:14 Bikos di husband wey nor bilive, God go save am, bikos of en wife wey bilive and di wife wey nor bilive, God go save am, bikos of en husband wey bilive.
1CO 7:15 But if di one wey nor bilive komot from di marriage, make e bi like dat. For dis kind kase, di broda or sista wey bilive, don dey free; bikos God wont make wi enjoy peace.
1CO 7:16 Yu wife! How yu take know sey yu nor go fit save yor husband? Yu husband! How yu take know sey yu nor go fit save yor wife?
1CO 7:17 For evry church, I dey tell di pipol sey make dem remain as dem bi wen Oga God Jesus choose and koll dem to bi en own. Naw, na di same tin I dey tell una so.
1CO 7:18 If yu don already sekonsaiz, make yu dey like dat. If dem neva sekonsaiz yu, make yu nor sekonsaiz.
1CO 7:19 Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law.
1CO 7:20 So make una nor try to shange as una bi wen God choose una.
1CO 7:21 If God koll yu wen yu bi slave, make yu nor let am worry yu. But if yu fit get yor freedom, make yu get am.
1CO 7:22 Slave wey God choose make e follow Jesus, don bikom free man thru Jesus Christ. So free man wey God choose make e follow Jesus, don turn to Christ savant.
1CO 7:23 God pay big prize for una, so make una nor bi slave to any oda pesin.
1CO 7:24 Make una stay as una bi wen God choose and koll una.
1CO 7:25 Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.
1CO 7:26 Dis time wey wi dey nor eazy at-all and wetin I tink bi sey, e go good make una stay as una bi naw.
1CO 7:27 If yu don marry, nor leave yor marriage. If yu neva marry, make yu nor worry yorsef about am.
1CO 7:28 If pesin wey neva marry before kon marry, e nor sin. But, pipol wey don marry go face plenty wahala and I dey try to help una, so dat una nor go face dat kind wahala.
1CO 7:29 My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.
1CO 7:30 If yu dey kry or laf; dey buy sometin or yu nor get money, all na di same tin.
1CO 7:31 E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.
1CO 7:32 And I nor wont make anytin trobol una. Man wey neva marry, make e dey do tins wey go make Christ happy for am.
1CO 7:33 But man wey don marry get plenty tins to worry about. E go must worry about tins for dis world, bikos e go wont make belle dey sweet en wife,
1CO 7:34 so e go dey tink about difren tins. Woman wey neva marry dey only tink of how to make belle sweet Christ. Dat time, dia body and mind dey pure. But woman wey don marry dey worry about dis world tins, bikos e wont make belle sweet en husband.
1CO 7:35 Wetin I dey tok na for una own good, nor bi to make una slave. I wont help una to dey live betta life and to love Christ pass any oda tin.
1CO 7:36 But if yu get patina and yu nor fit kontrol yorsef, den make yu go marry. Nor-tin dey bad for dat one.
1CO 7:37 But e betta, if yu fit kontrol yor body sey yu nor won marry naw.
1CO 7:38 E dey rite and okay to marry, but e betta sey yu nor marry at-all.
1CO 7:39 Wife suppose to stay with en husband until di man die. Den e fit go marry again, but di new husband must bi pesin wey dey follow Christ.
1CO 7:40 But I bilive sey, I dey obey God Spirit wen I sey make di woman nor marry, so dat e go dey happy well-well.
1CO 8:1 For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.
1CO 8:2 Di man wey tink sey e know sometin, neva still know as e suppose know.
1CO 8:3 But God know di pesin wey love am.
1CO 8:4 So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.
1CO 8:5 Dem dey koll many tins for heaven and eart, “gods and mastas,” but non of dem really bi god or masta.
1CO 8:6 But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
1CO 8:7 Nor bi evribody know dis tins. Some pipol don grow with di bilive sey juju dey alive. So wen dem dey chop meat wey dem give juju, dem go dey fear.
1CO 8:8 But wi know sey food nor fit bring us klose to God. Wi nor go luz anytin if wi nor chop or sey wi gain anytin if wi chop.
1CO 8:9 But make una dey kareful, so dat weak pesin among una nor go fall bikos una don dey free to chop anytin.
1CO 8:10 Bikos if weak pesin si yu wey know di word dey chop juju food, e go fit join yu chop di food wey dem sakrifice give juju.
1CO 8:11 Den wetin yu know don distroy pesin wey Christ die for.
1CO 8:12 If yu sin against yor brodas or sistas wey nor get strong heart and faith, yu don sin against Christ.
1CO 8:13 So, if food wey I dey chop go wound pesin wey dey follow Christ, I nor go ever chop meat again, so dat my brodas and sistas nor go sin.
1CO 9:1 I nor dey free? I nor bi apostle? Abi I neva si awa Oga God Jesus? Nor bi una dey show di work wey I don do?
1CO 9:2 If I nor bi apostle to oda pipol, at least I bi apostle to una, bikos na una bi di sign wey show sey I bi Jesus Christ apostle.
1CO 9:3 Wen pipol ask mi kweshon, I dey tell dem sey,
1CO 9:4 mi and Banabas fit chop and drink wetin wi like,
1CO 9:5 abi wi nor get rite to marry biliver for Christ?
1CO 9:6 Na only wi must work before wi go chop?
1CO 9:7 E get any soja wey dey pay ensef salari? Abi who plant vegitabol, nor dey chop for inside? Or who dey keep sheep nor dey drink from dia milk?
1CO 9:8 Una tink sey na only kommon sense I take dey tok all dis tins? Abi una don forget sey di law tok like dis too?
1CO 9:9 Moses sey, “Make una allow animal wey grind korn chop from wetin e dey grind.” So, una tink sey na di melu God dey worry for?
1CO 9:10 No! Na wi God dey tok about. Dem rite all dis tins for di law, so dat evribody wey work, go fit chop for harvest time.
1CO 9:11 So if wi don plant spiritual seed among una, e go dey too mush if wi ask for ordinary food and drink from una?
1CO 9:12 If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.
1CO 9:13 Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?
1CO 9:14 Na so too God kommand sey, doz wey dey prish di gospel, go chop thru di gospel wey dem dey prish.
1CO 9:15 But I nor dey use all dis rite and I nor dey rite dis tins so dat pesin go give mi sometin. E betta make I die, dan make anybody kon make mi stop to dey tok like dis.
1CO 9:16 Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!
1CO 9:17 If I prish bikos I wont prish, dem go pay mi, but even if I nor wont prish, di prishin na wetin God send mi kom do.
1CO 9:18 Wetin kon bi my gain? Na to prish di gospel without pay or na to use di rite wey I get, bikos I dey prish di gospel?
1CO 9:19 I nor bi anybody savant. But I don turn savant to evribody, so dat I go fit win many pipol for Christ.
1CO 9:20 Wen I dey with Jew pipol, I dey live like dem, so dat I go win dem for Christ. Na Moses Law dem dey follow, but I nor dey follow dat one. But I dey live as di law tok, so dat I go win souls kom meet Christ.
1CO 9:21 And wen I dey with pipol wey nor dey live by di law, I nor dey use di law for dem, so dat I go fit win dem. But dat nor mean sey, I go forget God law, bikos na Christ law dey rule mi.
1CO 9:22 Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
1CO 9:23 Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.
1CO 9:24 Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!
1CO 9:25 Pipol wey dey run, dey train well-well, so dat dem go win crown wey nor dey last, but wi dey run for crown wey go last forever.
1CO 9:26 So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.
1CO 9:27 Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.
1CO 10:1 My brodas, I wont make una remember wetin happen to awa papa dem wey follow Moses. God kloud protet dem as dem dey waka pass di Red Sea.
1CO 10:2 Na der dem for baptize dem wen dem dey follow Moses wey bi God savant.
1CO 10:3 All of dem chop and drink di same spiritual
1CO 10:4 bread and milk. Dem drink from di spiritual Rock wey follow dem go and dat Rock, na Jesus Christ.
1CO 10:5 But den, God nor dey happy with some among dem, so many of dem kon die for inside wildaness.
1CO 10:6 Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do,
1CO 10:7 or woship juju like some among dem. Just as God word sey, “Di pipol sidan to chop and drink, den dem kon start to play.”
1CO 10:8 Make wi nor follow ashawo life like some among dem, wey make 23,000 pipol die for one day.
1CO 10:9 So make wi nor tempt Christ as some among dem dey do before snake kon distroy dem.
1CO 10:10 Make una nor komplain like di way some for dem do before distroshon angel kon distroy dem.
1CO 10:11 Dem rite dis tins wey happen to dem to tish us lesin and na ezample for doz wey go dey wen di world go end.
1CO 10:12 So pesin wey tink sey e stand, make e take kare, if not, e go fall.
1CO 10:13 E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.
1CO 10:14 So my brodas, make una run from bad tins.
1CO 10:15 I dey tok to pipol wey get sense. Make una tink about wetin I dey tok.
1CO 10:16 Wen wi drink from di Oga God Supper cup, dat mean sey wi dey share from Christ blood. Wen wi chop from di bread wey wi divide, dat mean sey wi dey share for Christ body.
1CO 10:17 Bikos wi dey chop from one bread, all of us don bi one body, even doh wi many.
1CO 10:18 Israel pipol dey chop juju food, but dem still dey share for Christ altar.
1CO 10:19 I nor dey sey juju food or di one wey dem sakrifice mean anytin.
1CO 10:20 But wetin I mean bi sey, wetin bad pipol dey sakrifice, na for demon, nor bi for God.
1CO 10:21 Yu nor fit drink from God cup and demon cup for di same time.
1CO 10:22 Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?
1CO 10:23 Pipol sey, wi fit do evritin. Dat na true, but nor bi evritin dey good. Wi fit do evritin, but nor bi evritin dey good for di body.
1CO 10:24 Make pesin nor dey tink for ensef alone, but for oda pipol too.
1CO 10:25 Make una mind dey okay as una dey chop any meat wey dem dey sell for market.
1CO 10:26 Bikos God word sey, “Di eart and evritin wey dey inside, na di Oga God own.”
1CO 10:27 If pesin wey nor know God invite yu kom chop for en house, make yu chop wetin e give yu, nor ask kweshon, bikos of wetin dey yor mind.
1CO 10:28 But if di pesin tell yu sey, “Dem sakrifice dis food give juju,” make yu nor chop am bikos of di pesin wey tell yu and en konscience.
1CO 10:29 I nor mean yor konscience, but di oda pesin own. So bikos of wetin anoda pesin dey tink, I nor go fit do wetin I wont do?
1CO 10:30 If I tank God for my food, wetin go make anybody fight mi bikos of di food wey I tank God for?
1CO 10:31 But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.
1CO 10:32 Live yor life so dat yu nor go kause trobol for Jew or Greek pipol or for pipol wey dey God church.
1CO 10:33 Make una dey do as I dey do; bikos I dey always try to please evribody instead of mysef, bikos I wont make God save dem.
1CO 11:1 Make una follow mi as I dey follow Christ.
1CO 11:2 I dey praiz una, bikos una always dey do di tins wey I tell una,
1CO 11:3 but I wont make una undastand sey as Christ bi evribody head, na so too husband bi head for en house and na God bi Christ head.
1CO 11:4 So any man wey dey pray or prish God message kon kover en head dey woship God, dey disgrace Christ.
1CO 11:5 And any woman wey dey pray or prish God message and e nor kover en head, dey disgrace en head, wey bi en husband; e for betta sey di woman shave en head.
1CO 11:6 If di woman nor one kover en hair, den make e go shave am.
1CO 11:7 Man nor nid to kover en head, bikos e dey show as God glory bi. But woman dey show as man glory bi;
1CO 11:8 bikos God nor kreate di man from woman, but E kreate di woman from man.
1CO 11:9 God nor kreate man bikos of woman, but E kreate woman, bikos of man.
1CO 11:10 Bikos of di angels, di woman must kover en head to show sey na en husband dey protet am.
1CO 11:11 As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body.
1CO 11:12 Aldo God make woman from man, but na woman dey born evribody, even doh na God kreate evribody.
1CO 11:13 Make una judge by unasef weda e dey good for woman to dey prish God word wen e nor kover en head.
1CO 11:14 Wetin make pipol for di world dey sey, na disgrace for man to karry long hair?
1CO 11:15 But long hair dey make woman fine well-well. God give di woman di long hair, so dat di hair go kover di woman head.
1CO 11:16 Dis na how dem dey do tins for God church, so nobody go fit follow mi kworel for wetin I dey tok.
1CO 11:17 Di way una dey woship God, dey kause wahala pass di good wey E dey do for una. Bikos of dis, I nor go fit praiz una.
1CO 11:18 Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true.
1CO 11:19 Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una.
1CO 11:20 Wen una dey togeda, nor bi di Oga God Supper una dey chop?
1CO 11:21 But before evribody go rish di meetin, some pipol among una don start to chop and drink, wen odas dey hongry.
1CO 11:22 Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.
1CO 11:23 I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand
1CO 11:24 and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.”
1CO 11:25 Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”
1CO 11:26 Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.
1CO 11:27 Bikos of dis, anybody wey chop di bread or drink di wine anyhow wey e like, dat pesin don sin against Christ body and en blood.
1CO 11:28 So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup.
1CO 11:29 But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup.
1CO 11:30 Na dis make many of una wey nor well, weak and some among una don even die.
1CO 11:31 But if wi judge awasef, God nor go ponish us.
1CO 11:32 But wen God judge and ponish us, E dey do am, so dat E nor go kondemn us with dis world.
1CO 11:33 My brodas and sistas, make una dey wait for evribody, before una go start to chop di Oga God Supper.
1CO 11:34 But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
1CO 12:1 My friends, una bin ask mi about spiritual gifts.
1CO 12:2 I won make una remember sey, before una bigin follow Christ; na juju una dey serve.
1CO 12:3 Naw, I wont make una know sey, anybody wey God Spirit dey lead, go sey, Jesus naim bi Oga God and e nor go ever curse am.
1CO 12:4 Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit.
1CO 12:5 And wi get difren ways to serve God
1CO 12:6 and each of us dey do difren tins. But na di same God dey work for awa life and E dey help us do evritin.
1CO 12:7 Each of us get difren gift wey di Spirit give us and wi dey use am do good.
1CO 12:8 Some among us dey fit speak with wisdom and odas with knowledge, but na di same Spirit dey give us all dis gifts.
1CO 12:9 To oda pipol, di Spirit dey give dem faith or di pawa to heal sick pipol.
1CO 12:10 Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean.
1CO 12:11 But na di same Spirit dey do all dis tins and e dey choose di kind gift wey e wont give each pesin.
1CO 12:12 Christ body get difren part like evry oda body.
1CO 12:13 Some pipol among us na Jew and odas na Gentile. Some na slave and odas dey free. But God Spirit baptize us kon make us part for Jesus Christ body. Naw, all of us dey drink from dat same Spirit.
1CO 12:14 Nor bi only one part awa body get, but dem many.
1CO 12:15 If di leg for awa body sey, “I nor bi hand, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di leg still dey?
1CO 12:16 And if di ear sey, “I nor bi eye, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di ear still dey?
1CO 12:17 If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.
1CO 12:18 But God don put evry part for awa body, just as E wont am.
1CO 12:19 If na only one part dey di body, den di body nor go bi as e suppose bi again.
1CO 12:20 But as e bi so, na many parts dey make one body.
1CO 12:21 So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.”
1CO 12:22 So, wi nor go fit do anytin with awa body without di part wey wi feel sey, e dey weak.
1CO 12:23 Di part wey wi tink sey dey important, wi dey trit dem with respet and di part wey nor really dey outside, wi dey trit dem well.
1CO 12:24 But awa body nor nid all dis treatment. Bikos na God make awa body, so di part wey wi fit sey nor dey important, dey important well-well.
1CO 12:25 God do am like dis, so dat all di parts for di body go dey work togeda and each part go dey kare for oda part.
1CO 12:26 If one part dey sofa, di oda parts dey sofa too. But if dem praiz one part, di oda parts go dey happy.
1CO 12:27 All of una dey Christ body. And each of una, na part for di body.
1CO 12:28 So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.
1CO 12:29 Nor bi evribody bi apostle. Nor bi evribody bi tisha. Nor bi evribody fit do mirakle.
1CO 12:30 Nor bi evribody fit heal sick pipol. Nor bi evribody fit tok wetin dis language mean.
1CO 12:31 But I wont make una ask for di gift wey betta pass, so dat I go show una di way wey betta pass all dis tins.
1CO 13:1 If I dey tok di language wey human being and angels dey tok;
1CO 13:2 if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.
1CO 13:3 If I give pipol evritin wey I get kon sey make dem burn mi alive, but I nor love odas, I nor go gain anytin.
1CO 13:4 Love dey kind and patient, e nor dey jealous or boast
1CO 13:5 or dey proud. Love nor get long-trot or dey vex. E nor dey remember di bad tins wey odas do.
1CO 13:6 E nor dey happy with wiked pipol, but e dey happy with di trut.
1CO 13:7 Love dey bear evritin and e get faith, hope and patient.
1CO 13:8 Love nor dey fail and e go dey forever. Pipol nor go profesai forever and doz wey dey tok with difren-difren language, go stop. For dat time, wi go forget evritin wey wi know.
1CO 13:9 Naw, wi nor know evritin and awa profesy nor komplete.
1CO 13:10 But one day, wetin dey pafet go kom and wetin nor dey pafet, go vanish.
1CO 13:11 Wen wi neva know Christ, wi dey tink and tok like small shidren. But naw wen wi don know am, wi nor dey do like small shidren again.
1CO 13:12 Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.
1CO 13:13 And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.
1CO 14:1 Na love suppose guide una. So make una dey fight to get di gift wey di Holy Spirit dey give, especially di gift to profesai.
1CO 14:2 Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem.
1CO 14:3 But wen una profesai, pipol go undastand una and odas go help una. Dem go get konfort kon dey okay.
1CO 14:4 Pesin wey dey tok with difren language, dey help ensef. But di one wey dey profesai, dey help di church.
1CO 14:5 I for like make all of una dey tok with difren language, but I wont make una dey profesai. Bikos profesy go do una more good, dan sey una dey tok with difren language wey pipol nor fit undastand, unless somebody esplain di meaning give di pipol for di church.
1CO 14:6 My brodas and sistas, wetin una go gain if wen I kom, I dey tok with difren language wey una nor undastand and I nor esplain am? How I go fit help una den, unless I tell una wetin God tell mi or make una know wetin dem profesai and tish?
1CO 14:7 If all music instrument get di same sound, how una go take know di one wey bi trumpet or harp?
1CO 14:8 If trumpet make sound wey pipol nor undastand, who go dey ready to go fight war?
1CO 14:9 Na so e bi wen una dey tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. If nobody fit undastand wetin una dey tok about, dat mean sey na breeze una dey follow tok.
1CO 14:10 Dis world get difren language and all of dem dey good.
1CO 14:11 But if odas nor undastand wetin una tok, den dem go bi like strenjas to una.
1CO 14:12 Na so e bi with una too. If una really wont di gift wey di Spirit dey give, make una choose di one wey di church go gain from.
1CO 14:13 So wen wi tok with difren-difren language wey odas nor undastand, make wi pray make God give us di pawa to esplain wetin e mean.
1CO 14:14 For ezample, if I pray with language wey nobody undastand, my spirit dey pray, but my mind nor undastand di tins wey I dey pray for.
1CO 14:15 So wetin I go do? Bikos e get time wey I go pray with my spirit and time wey I suppose pray with my mind. Sometaim, I suppose sing with my spirit and oda time, I go sing with my mind.
1CO 14:16 If some strenjas dey for where una for dey woship God for spirit and dem nor undastand una, how dem go take know wen to sey, “Amen”?
1CO 14:17 Una fit really dey woship God well-well, but nobody go gain from am, bikos dem nor undastand wetin una dey tok.
1CO 14:18 I tank God sey I dey tok with difren-difren language pass all of una.
1CO 14:19 But wen I dey church, e betta make I speak five betta words to tish odas, dan to speak 10,000 words wey pipol nor undastand.
1CO 14:20 My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.
1CO 14:21 God word sey: “I go use strenjas wey dey speak wetin odas nor undastand, take tok to my pipol. Dem go tok to dem with strenj language, but my pipol nor go listin to mi.”
1CO 14:22 So, language wey odas nor undastand, fit mean sometin to pipol wey nor bilive, but nor bi to pipol wey bilive.
1CO 14:23 So if di whole church bigin tok with difren-difren language, den some pipol wey bi unbilivers or doz wey nor undastand kon waka enter di church, dem nor go tink sey all of una don dey kraze?
1CO 14:24 But if evribody dey profesai and unbilivers or pipol wi nor undastand enter di church, dem go know sey dem bi sinnas and dem go won turn from dia sin kom meet God, bikos of wetin una dey tok.
1CO 14:25 Den God go tell una di sekret wey dey dia heart. Den dem go knee down kon tell God sey, “Wi don really bilive sey yu dey with dis pipol.”
1CO 14:26 My friends, wen una gada to woship, una must do evritin to help one anoda. Na so e suppose bi wen somebody dey tish, sing, profesai, tok with difren-difren language or dey esplain wetin di pesin tok.
1CO 14:27 Wen una dey togeda, make e nor pass two or three pipol wey go tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. One pesin go tok, before anoda and make pesin dey, wey go esplain give odas wetin di pesin dey tok.
1CO 14:28 If nobody dey wey go fit esplain wetin yu dey tok, make yu nor tok at-all for di meetin, but yu fit tok am between yu and God.
1CO 14:29 Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well.
1CO 14:30 And if one among di pipol wey sidan receive message from God, di pesin wey dey tish must stop make di pesin for tok.
1CO 14:31 Make di pipol nor tok at wons, so dat all of una go learn sometin and una go dey okay.
1CO 14:32 Pesin wey bi profet must dey ready to stop, so dat anoda pesin go tok, bikos profet suppose to fit kontrol en own spirit,
1CO 14:33 bikos God wont make dem do evritin well. Wen God pipol meet for church,
1CO 14:34 make wimen nor dey tok. Make dem kwayet dey listin, just as Moses Law tish.
1CO 14:35 If dem won know about sometin, dem fit ask dia husband wen dem rish house. Bikos na disgrace for woman to tok for church.
1CO 14:36 God message nor start with una and nor bi only una don hear am.
1CO 14:37 If una dey tink of unasef as profet or pesin wey di Spirit dey use, den una go know sey I dey rite only di tins wey God kommand mi.
1CO 14:38 So make una nor listin to anybody wey nor bilive wetin I dey rite.
1CO 14:39 My friends, make una dey try to profesai and make una nor stop anybody wey dey tok with difren-difren language even doh odas nor undastand wetin e dey tok.
1CO 14:40 But make una dey do tins as e suppose to bi.
1CO 15:1 My brodas and sistas, I wont make una remember di gospel wey I prish give una,
1CO 15:2 di one wey una asept and dey stand on. Na dis gospel go save una if una whole di message wey I prish give una well-well, unless una faith nor strong.
1CO 15:3 Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word
1CO 15:4 and dem beri am, den God raiz am up afta three days as dem rite for God word.
1CO 15:5 Christ appear to Pita, den to di twelf apostles.
1CO 15:6 Den e appear to more dan five hundred bilivers. Some of dem still dey alive, but some don die.
1CO 15:7 Den e appear to James, den to all di apostles.
1CO 15:8 Finally, e appear to mi; even doh I bi like pikin wey dem born before di time rish,
1CO 15:9 bikos na mi small pass among all di apostles. But, I kause many wahala for God church, so dem nor suppose koll mi apostle.
1CO 15:10 But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.
1CO 15:11 But e nor mean anytin if I prish or dem prish, as long as all of una bilive di message wey wi dey prish.
1CO 15:12 Naw, if wi dey prish sey God raiz Jesus from deat, wetin make some pipol among una dey sey resureshon nor dey?
1CO 15:13 If resureshon nor dey, dat mean sey Christ nor raiz-up from grave.
1CO 15:14 And if Christ nor raiz-up, den awa prishin and una faith nor mean anytin.
1CO 15:15 So, if resureshon nor dey, dat mean sey, evritin wey wi don tok about God, na lie, bikos wi sey E raiz Jesus from deat wen E nor raiz am.
1CO 15:16 If resureshon nor dey, na-im bi sey Christ nor raiz-up from deat.
1CO 15:17 If God nor raiz Christ from deat, den una faith dey yuzles and una still dey inside una sin.
1CO 15:18 And doz wey bilive Christ before dem die, don lost bi dat.
1CO 15:19 Bikos if na only for dis life wi get hope for Christ, den awa kase worse pass any oda pesin own for dis world.
1CO 15:20 But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.
1CO 15:21 Just as pipol go die bikos of Adam, na so too wi go raiz-up kom life, bikos of Christ.
1CO 15:22 Adam bring deat kom meet all of us, but Christ bring life kom.
1CO 15:23 But all of us must wait for awa turn. Na Christ God first raiz kom life and Christ go raiz en pipol wen e kom back.
1CO 15:24 Den afta Christ don distroy all pawas, di world go end and e go give di kingdom to God wey bi di Papa.
1CO 15:25 Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa
1CO 15:26 and di last enemy wey e go distroy, na deat.
1CO 15:27 Wen God word sey, e go put evritin under en pawa, e nor mean sey, God dey among dem. Bikos na God put evritin under Jesus Christ pawa.
1CO 15:28 And wen evritin don dey under God pikin pawa, e go kon put ensef under God wey put evritin under en pikin pawa. Den God go kon bi evritin to evribody.
1CO 15:29 If resureshon nor dey, wetin make dem dey baptize pipol for Christ?
1CO 15:30 And wetin make us dey risk awa life
1CO 15:31 kon dey face deat evriday? Na di pride wey I get for una, bikos of awa Oga God Jesus Christ, naim make mi dey tok all dis tins.
1CO 15:32 If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.
1CO 15:33 Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”
1CO 15:34 Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.
1CO 15:35 Some among una dey ask sey, “How pipol wey don die go take kom dis world back? Wish kind body dem go get?”
1CO 15:36 Una bi fool! Wetin pesin plant nor dey grow, unless di seed first die.
1CO 15:37 Wetin una plant, na ordinary seed, but na di full plant dey grow kom out.
1CO 15:38 Dis na bikos God dey give dem di kind body wey E wont make di plant get.
1CO 15:39 Pipol, animals, birds and fish, na flesh God take make all of dem, but all of dem get difren flesh.
1CO 15:40 As evritin for heaven get body, na so too evritin for dis eart get body. But one body difren from di oda ones.
1CO 15:41 Di sun nor bi like di moon; di moon nor bi like di star and di stars difren from each oda.
1CO 15:42 Na so e go bi afta wi don raiz-up from deat. Dis body wey wi get naw, go die, but di body wey wi go take raiz from deat, go dey forever.
1CO 15:43 Wen dem beri dis body, e dey weak and go rotin, but wen God don raiz us up from deat, di body go kon dey fine and strong forever.
1CO 15:44 As Fisical body dey, na so too spiritual body dey. And awa Fisical body go shange to spiritual body.
1CO 15:45 Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.”
1CO 15:46 Wi si sey di one wey get spiritual body nor first kom. E kom afta di one wey get Fisical body.
1CO 15:47 Na san God take make di first man, but di sekond man kom from heaven.
1CO 15:48 Evribody body for eart, bi like di first man and evribody body for heaven, bi like di sekond man own.
1CO 15:49 Just as wi bi like di first man wey kom from eart, wi go bi like di sekond man wey kom from heaven.
1CO 15:50 My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever.
1CO 15:51 I won tell una one big sekret: Nor bi all of us go die, but all of us go shange.
1CO 15:52 Before wi klose awa eye open am, e go don happen. As dem dey blow di last trumpet, all doz wey don die go raiz. All of us go shange, so dat wi nor go die again.
1CO 15:53 Awa body wey don die and rotin go kon shange to body wey nor go ever die or rotin.
1CO 15:54 Di body wey wi get naw, dey weak and e go die. But God go shange am to body wey go dey forever. So wetin dem rite for God word go kon happen sey: “Deat nor fit win di fight!”
1CO 15:55 “Yu deat! Where yor pawa? Yu deat! How yu go take shaut sey yu win?”
1CO 15:56 Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin.
1CO 15:57 So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ.
1CO 15:58 So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
1CO 16:1 Wen una kollect money from God pipol, I wont make una do as I tell di pipol wey dey di church for Galatia sey make dem do.
1CO 16:2 Evry Sunday, make each pesin dey keep some money for korna from di one wey e don work, as God help am rish, so dat una nor go nid to kollect money wen I kom.
1CO 16:3 Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem.
1CO 16:4 But if una sey make I go too, den, dem go follow mi go.
1CO 16:5 And afta I don finish for Masidonia, I hope to kom si
1CO 16:6 and stay with una for sometaim. May bi I fit stay till dry sizin finish, so dat una go fit help mi for anywhere wey I won go.
1CO 16:7 If God go let mi, I nor go one branch si una for small time naw, bikos I go like kom leta, so dat I go fit spend more time with una.
1CO 16:8 But I go stay for Efesus until Pentekost go finish,
1CO 16:9 bikos plenty work dey wait for mi for der, even doh di shalenge strong well-well.
1CO 16:10 Wen Timoti kom, make una nor make am fear at-all, bikos na God work wey I dey do, naim e dey do too.
1CO 16:11 So make evribody respet am, den make una send am kom meet mi with peace, bikos I dey espect am with di oda brodas.
1CO 16:12 I don try well-well make Apollos for fit follow oda bilivers kom visit una, e nor won kom naw, but e go kom leta.
1CO 16:13 Make una shine una eye and dey strong for una faith and stand with boldness.
1CO 16:14 For evritin wey una dey do, make una dey show love.
1CO 16:15 Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una
1CO 16:16 dey obey dis leaders and doz wey dey follow una do God work.
1CO 16:17 I dey happy sey Stefanas, Fortunatus and Akaikus don kom; dem kom ripresent una
1CO 16:18 and dem don let belle sweet mi, just as dem make belle sweet una. E good make wi dey tok about pipol like dem.
1CO 16:19 Pipol for di church wey dey Asia aria dey greet una; Akwila and Priscilla with di church pipol wey dey meet for dia house, dey greet una too.
1CO 16:20 All di brodas sey make I greet una.
1CO 16:21 Na mi Paul, rite dis leta with my own hand.
1CO 16:22 Anybody wey nor love Christ, curse dey en head!
1CO 16:23 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
1CO 16:24 Make my love for Jesus Christ, dey with all of una too.
2CO 1:1 Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia.
2CO 1:2 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
2CO 1:3 Make wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, di God wey dey give mesi and konfort,
2CO 1:4 E dey help us wen wi dey trobol, so dat wi go fit help odas thru di help wey E help us.
2CO 1:5 Just as wi sofa with Christ, na so too wi go get help from God thru Christ.
2CO 1:6 If wi sofa, na for una good and salvashon; if wi dey okay, den una go fit bear di kind sofa wey wi bear.
2CO 1:7 So, wi get hope about una, bikos wi know sey as una dey follow us sofa, na so una go still follow us get konfort.
2CO 1:8 My brodas and sistas, wi wont make una know about di wahala wey wi face for Asia aria. Di trobol wey wi face, heavy well-well and life kon taya us.
2CO 1:9 True-true, wi tink sey wi go die. But dis happen so dat wi nor go just trust awasef, but wi go trust God wey dey wake pipol from deat.
2CO 1:10 E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.
2CO 1:11 As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.
2CO 1:12 Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
2CO 1:13 Bikos evritin wey I rite, na wetin una go fit read and undastand. But I hope sey una go undastand am well,
2CO 1:14 just as una don undastand us rish and na wi make una dey proud and na una go make us proud too, for di day wey Jesus go kom.
2CO 1:15 Na with dis mind I bi won take kom meet una before, so dat wi go bless una again.
2CO 1:16 Bikos I plan to visit una wen I dey go Masidonia and wen I dey kom back, so dat una go help mi wen I dey travel go Judea.
2CO 1:17 So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons?
2CO 1:18 But as God dey faithful, wetin wi dey prish give una nor bi make e for bi just “Yes” or “No.”
2CO 1:19 Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”
2CO 1:20 And evritin wey God promise us, na “Yes” thru Jesus Christ. Dat na why awa “Amen” thru Jesus Christ dey give God glory.
2CO 1:21 Na God make wi and una dey sure sey wi dey inside Christ. Na God choose us from odas
2CO 1:22 and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.
2CO 1:23 Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again.
2CO 1:24 Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.
2CO 2:1 So I sey I nor go kom visit una, so dat una nor go vex again.
2CO 2:2 Bikos if I make una vex, who go make mi dey happy apart from una wey dey vex for mi?
2CO 2:3 Na dis make mi rite dis tin give una, so dat wen I kom, I nor go kon dey vex for di pipol wey suppose make mi happy, bikos I know sey if I dey happy, una go dey happy too.
2CO 2:4 Na pain for my heart I take rite dis leta give una, nor bi to make una vex, but na to let una know di kind love wey I get for una.
2CO 2:5 Naw if anybody don make pesin vex, nor bi only mi e make vex, but na all of una. (I dey tok like dis bikos I nor won too vex for di pesin).
2CO 2:6 Di way wey una ponish dis pesin, don rish.
2CO 2:7 So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am.
2CO 2:8 So make una let am know sey una really love am.
2CO 2:9 I rite dis leta give una, so dat I go know weda una dey obey wetin I tell una.
2CO 2:10 Wen una forgive pesin for wetin e do, misef go forgi-am. Bikos wen I forgive (if I really nid to forgive), I do am for Christ present, bikos of una,
2CO 2:11 so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo.
2CO 2:12 Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi,
2CO 2:13 my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia.
2CO 2:14 But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.
2CO 2:15 Bikos wi bi like sweet smell wey Christ offa give God wey dey spread among doz wey dey save and doz wey don lost.
2CO 2:16 To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins?
2CO 2:17 Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
2CO 3:1 Wi don dey boast about awasef again? Wi nor nid una to rite sey, wi dey good, even doh odas dey wont am like dat!
2CO 3:2 Na una bi di leta wey Christ rite for awa heart, wey evribody know and dey read.
2CO 3:3 E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.
2CO 3:4 Wi get dis kind mind for God, bikos of Jesus Christ.
2CO 3:5 Wi nor dey sey wi go fit do all dis tins by awasef, but na God give us di pawa wey wi take do dem.
2CO 3:6 Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.
2CO 3:7 Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,
2CO 3:8 den how di Spirit ministry wey get glory, go kon bi, since e nor dey fade?
2CO 3:9 Bikos if glory dey for di law wey make God kondemn pipol, den di Spirit glory wey dey give life, na how E go betta rish?
2CO 3:10 Wetin get glory naw, nor get glory again, bikos di glory wey di Spirit wey dey kom afta am get, big well-well.
2CO 3:11 If Moses face get glory, den how di glory wey dey di Pesin face wey nor dey die, go bi?
2CO 3:12 Na dis hope wi get and naim dey make us tok without fear.
2CO 3:13 Wi nor bi like Moses wey take klot kover en face, so dat Israel pipol nor go si di glory wey go fade komot.
2CO 3:14 But dia mind dey klose. And till today, dia mind still block wen dem dey read di old kovenant. Dem neva remove am, bikos na for only Christ body, dem go fit take remove am.
2CO 3:15 So till today, anytime wey dem read wetin Moses rite, sometin dey kover dia mind,
2CO 3:16 but wen pesin turn kom meet God, dat tin go komot from en life.
2CO 3:17 Na God bi di Spirit and anywhere en Spirit dey, pipol go dey free.
2CO 3:18 All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.
2CO 4:1 So as wi get dis ministry, just as God don show us mesi, awa hope don strong well-well.
2CO 4:2 But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
2CO 4:3 But even if dem use klot take kover di gospel wey wi dey prish, doz wey don lost, na only dem nor go si am,
2CO 4:4 bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.
2CO 4:5 Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.
2CO 4:6 Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
2CO 4:7 But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa.
2CO 4:8 Wi dey face wahala for difren korna, but awa body nor skata; wi dey konfuse sometaim, but wi nor dey luz hope,
2CO 4:9 pipol dey ponish us, but God nor let us die; dem dey nak us for groun, but dem nor fit distroy us.
2CO 4:10 As wi dey waka, wi karry Christ deat for awa body, so dat pipol go si Jesus life for awa body too.
2CO 4:11 Dem always dey won kill wi wey dey alive bikos of Jesus Christ, so dat dem go si Jesus life for awa ordinary body.
2CO 4:12 Bikos of dis, deat dey work inside us, but life dey work inside una.
2CO 4:13 But as e bi sey wi get di same spirit wey dey give faith, just as dem rite sey, “I bilive; naim make mi dey tok.” So wisef bilive, naim make us dey tok too.
2CO 4:14 Wi do like dis, bikos wi know sey di Pesin wey raiz-up Jesus, go still raiz us up with Jesus and E go take wi and una enter en kingdom.
2CO 4:15 All dis tins na for una good, so dat God grace wey dey rish many pipol evriday, go make pipol dey tank God more-more and all di glory go bi en own.
2CO 4:16 So, make wi nor luz hope, bikos even if awa body dey die go small-small, di Pesin wey dey inside us, dey fresh evriday.
2CO 4:17 Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world.
2CO 4:18 Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.
2CO 5:1 Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.
2CO 5:2 Bikos for dis awa house for eart, wi dey struggol, bikos wi nor fit wait to wear awa new body for heaven.
2CO 5:3 Afta wi don wear awa new body for heaven, wi nor go dey naked again.
2CO 5:4 Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.
2CO 5:5 Naw, di Pesin wey prepare us for dis tins, na God wey give us di Spirit, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E get for us.
2CO 5:6 So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,
2CO 5:7 bikos wi dey live awa life with faith, nor bi with wetin wi dey si.
2CO 5:8 So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.
2CO 5:9 So, weda wi dey alive or wi don die, wi dey do evritin wey wi fit do to make Christ happy.
2CO 5:10 Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.
2CO 5:11 So, bikos wi know wetin e mean to fear God, naim make us dey prish and beg pipol. But God know us well-well and I hope sey una know us well-well for una mind too.
2CO 5:12 Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind.
2CO 5:13 If wi dey kraze, na bikos of God; but if wi nor dey kraze, na bikos of una.
2CO 5:14 Bikos na Christ love dey kontrol us since wi know sey, Christ die for evribody; so evribody don die.
2CO 5:15 And e die for evribody, so dat evribody wey dey live nor go live for diasef again, but for di Pesin wey die and wake-up afta three days.
2CO 5:16 So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.
2CO 5:17 So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!
2CO 5:18 All dis tins dey kom from God wey make us en friends bikos of Christ and E still give us di ministry wey go make pipol bi en friend.
2CO 5:19 So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.
2CO 5:20 Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”
2CO 5:21 Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.
2CO 6:1 Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive.
2CO 6:2 Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!
2CO 6:3 Wi nor dey do anytin wey go make anybody vex, so dat nobody go si any fault for awa work.
2CO 6:4 But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times;
2CO 6:5 for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time.
2CO 6:6 Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol;
2CO 6:7 thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand;
2CO 6:8 for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.
2CO 6:9 Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us;
2CO 6:10 wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.
2CO 6:11 So, una wey bi Korint pipol, wi don open awa heart tell una evritin.
2CO 6:12 Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us.
2CO 6:13 So make wi make am ekwol. I dey tok to una like sey una bi my shidren, so make una open una heart for us too.
2CO 6:14 Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda?
2CO 6:15 And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive?
2CO 6:16 Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
2CO 6:17 Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una
2CO 6:18 kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.
2CO 7:1 So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.
2CO 7:2 Make una allow di gospel enter una heart bikos wi nor do bad to anybody or fall anybody business or play anybody wayo.
2CO 7:3 I nor dey tok dis one to kondemn una, bikos I don tell una before sey, una dey awa mind and wi with una go die and live togeda with Christ.
2CO 7:4 For inside all dis sofa wey wi dey sofa, I still trust and dey boast well-well about una, bikos I get mind for una and my happiness full dey trowey.
2CO 7:5 Even wen wi enter Masidonia, wi nor rest at-all, but dem trobol us from difren korna; wahala for outside, fear for inside.
2CO 7:6 But God wey dey help pipol wey nor happy, naim kon help us wen Titus kom.
2CO 7:7 Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.
2CO 7:8 Bikos even if I make una vex with my leta, e nor pain mi sey I rite am (even doh e pain mi as I know sey e make una vex, aldo una vexnashon nor tey).
2CO 7:9 Naw I dey happy, nor bi bikos una dey vex, but bikos una vexnashon make una turn from sin kom meet God. Na so God plan una vexnashon, so dat bad tins nor go happen to una bikos of dis vexnashon wey wi kause for una.
2CO 7:10 Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am.
2CO 7:11 Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter.
2CO 7:12 I nor rite dis leta give una bikos of di pesin wey do bad or di pesin wey dem do di bad to, but na to show una how una won work for God bikos of us.
2CO 7:13 So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.
2CO 7:14 I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too.
2CO 7:15 And wen e remember how una obey and welkom am with respet and fear, di love wey e get for una, kon strong well-well.
2CO 7:16 Evritin dey make mi happy, bikos di trust wey I trust una, nor dey shake.
2CO 8:1 Awa brodas and sistas, wi don tell una about di grace wey God give di pipol for di church for Masidonia sey,
2CO 8:2 even wen dia sofa strong well-well; dem still dey happy and wen dem nor get money at-all; dem still dey fine money give us.
2CO 8:3 I bi witness sey dem dey give akordin to wetin dem get. Sometaim, dem dey give pass wetin dem get. Nobody dey force dem to do like dat, but dem dey do am from dia own mind
2CO 8:4 and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give.
2CO 8:5 Dem dey do like dis, nor bi only as wi wont am, but na bikos dem don first give demsef to God, den dem kon give demsef to us as God wont.
2CO 8:6 Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.
2CO 8:7 But as una dey do well for evritin: For faith; for tok; for wetin una know and as una won do di work well, bikos una love us, make una make sure sey una dey do dis good with all una heart.
2CO 8:8 Nor bi sey I dey kommand una, but I won si weda una love na really won like di oda church pipol own.
2CO 8:9 Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.
2CO 8:10 Na wetin I tink for di matter bi dis: Una start well last year for how una dey give and how una dey won give,
2CO 8:11 so e betta make una just finish wetin una start, so dat di way wey una take start, na so too una go still take finish am as una pawa rish.
2CO 8:12 Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.
2CO 8:13 I nor dey tok dis one, so dat wen una don give oda pipol, dem go kon get and una go kon dey sofa, but na to make sure sey tins dey ekwol.
2CO 8:14 As tins bi naw, di money wey una get go help dem as dem nor get, so dat one day, di money wey dem go get go still help una wen una nor get, dat time evritin go kon dey ekwol, bikos
2CO 8:15 dem rite for God word sey: “Di pesin wey gada plenty, nor go get plenty and di pesin wey gada small, go get di one wey go rish am.”
2CO 8:16 Wi tank God wey give Titus di kind mind wey I get to help una.
2CO 8:17 Bikos e nor only gri for wetin wi ask am, but e dey help una well-well and nobody force am kom meet una.
2CO 8:18 And di broda wey all di church dem dey praiz, bikos of how e dey prish di gospel, wi dey send am follow Titus too and
2CO 8:19 bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.
2CO 8:20 Wi dey do like dis, so dat nobody go komplain as wi dey share dis gift.
2CO 8:21 Bikos wi dey try to do wetin dey rite, nor bi only for God eye, but for pipol eye too.
2CO 8:22 So wi dey send awa broda follow dem; awa broda wey wi don test plenty times kon si sey e get di mind to help and e ready to help naw, bikos e trust una well-well.
2CO 8:23 But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.
2CO 8:24 So make una show dem sey, una love dem, so dat all di pipol for di church go know sey, di way wey wi dey boast about una, na true.
2CO 9:1 I nor nid to rite to una about how to help God pipol wey dey Jerusalem,
2CO 9:2 bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too.
2CO 9:3 But I dey send dis brodas kom meet una to make sure sey una dey ready; as I don tell dem before sey, una don already kollect money. So make una nor let shame katch mi, as I dey boast about una.
2CO 9:4 But if anybody for Masidonia follow mi kom meet una, den e si sey una neva ready to give, shame go katch us, (I nor go tok too mush) bikos wi trust una.
2CO 9:5 Naim make mi beg dis brodas make dem go for my front before di time go rish and make dem help una arrange di money wey una promise, so dat una go do am with una mind and nobody go force una.
2CO 9:6 Na wetin I dey tok bi dis; Pesin wey plant small, go harvest small, but di pesin wey plant plenty, go harvest plenty.
2CO 9:7 Make each of una give as e plan for en mind; nor bi with regret or like sey dem force am, bikos God love pesin wey dey give with happiness.
2CO 9:8 God go provide evritin wey una nid. Den, una go always get evritin wey una nid and di one wey una go fit give odas.
2CO 9:9 Just as dem rite for God word, “E don skata for evriwhere, e don give to poor pipol and en raitiousness, go dey forever.”
2CO 9:10 Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever.
2CO 9:11 E go make una get enough money for evritin, so dat evritime, una go fit dey give well-well and di pipol wey una give money, go always dey tank God.
2CO 9:12 Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God.
2CO 9:13 Bikos of una work, pipol go praiz God, bikos una dey obey Christ word wey una bilive and una dey share evritin wey una get with good mind.
2CO 9:14 So, bikos of God big grace wey E give una, pipol dey pray for una with strong love.
2CO 9:15 Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.
2CO 10:1 Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol,
2CO 10:2 I take am beg una, so dat wen I kom, I nor go nid to tok with vexnashon about pipol wey si us like yeye pipol (bikos I dey fear sey na so e go bi).
2CO 10:3 Bikos even doh wi dey for dis world, wi nor dey fight as pipol wont am.
2CO 10:4 Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol;
2CO 10:5 pipol wey dey karry body up; doz wey nor wont make odas know God and as wi dey do like dis, pipol dey obey Christ.
2CO 10:6 And wen una don show sey una dey fear God, wi go always dey ready to ponish doz wey dey disobey God.
2CO 10:7 Na only tins wey eye fit si, naim una know. If anybody dey sure sey e bilong to Christ, make e tink about am again: If e bilong to Christ, den wi na Christ own too.
2CO 10:8 Bikos if I boast small about di authority wey Jesus give us make wi take build, instead of to distroy una, I nor go shame to do am.
2CO 10:9 I nor wont make una dey fear, bikos of wetin I rite,
2CO 10:10 bikos some pipol dey sey, “En letas dey heavy and get pawa well-well, but if yu si am for groun, e nor get pawa and e nor even fit tok well.”
2CO 10:11 Make doz pipol know sey, “Wetin wi tok for leta wen wi nor dey with una, wi dey do am wen wi dey with una.”
2CO 10:12 Wi nor go kompare awasef with doz wey sey dem good well-well or kon put awasef for di same group. But wen dem dey measure and kompare demsef with demsef, e dey show sey dem nor get sense.
2CO 10:13 But wi nor go boast pass as wi suppose boast; wi go boast akordin to di work wey God give us and una dey inside dat work too.
2CO 10:14 Wi nor dey do awa work pass as wi suppose do am wen wi dey with una, bikos na wi bi first to bring Christ message kom meet una.
2CO 10:15 Wi nor dey boast anyhow about di work wey oda pipol do, but wi dey hope sey as una faith dey grow well-well, awa work among una go big, just as God share am give us,
2CO 10:16 so dat wi go fit prish di gospel for oda kountries wey far pass una own. So make wi nor boast about di work wey odas do for oda aria.
2CO 10:17 But pesin wey won boast, make e boast about di work wey Jesus do.
2CO 10:18 Bikos nor bi who praiz ensef dey rite, but na di pesin wey God like to praiz.
2CO 11:1 For wetin I won tok naw, make una bear with mi like sey I nor get sense!
2CO 11:2 I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ.
2CO 11:3 But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.
2CO 11:4 So, if anybody kon prish anoda Christ wey wi nor prish for una and una receive anoda spirit wey una nor receive before, or anoda gospel wey una neva hear before, dat mean sey, una don asept dem well.
2CO 11:5 I nor tink sey doz “supper apostle” betta pass mi.
2CO 11:6 But even doh I nor know how to tok, I know book. True-true, wi don let una know dis tins wey happen.
2CO 11:7 As I honbol mysef dey do di work, na sin I kommit? I dey do am, so dat una go fit grow up and wen I prish give una, I nor kollect money.
2CO 11:8 I shit di oda church dem, bikos I dey kollect money from dem, so dat I go dey work with una for free!
2CO 11:9 Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am.
2CO 11:10 True-true, as Christ trut dey inside mi, nobody go fit stop mi for di way I dey boast for Akaia.
2CO 11:11 Why? Na bikos I nor love una? No! God know sey I love una!
2CO 11:12 And I go kontinue to do wetin I dey do, so dat doz apostles nor go get rizin to boast sey, dem dey do di same work with us.
2CO 11:13 Bikos dem bi fake apostles; pipol wey dey lie and pritend like sey dem bi Jesus Christ apostles.
2CO 11:14 E nor sopraiz us, bikos even Satan dey pritend sey en na angel wey get lite.
2CO 11:15 So e nor sopraiz us sey, en savants dey pritend too like sey dem bi savant wey dey do wetin good for God eye. For di end, dem go gain wetin fit di tins wey dem dey do.
2CO 11:16 I dey tell una again, make anybody nor tink sey I bi fool. But if una tink so, den make una asept mi as fool, so dat misef go boast small.
2CO 11:17 Wetin I dey boast about so, nor bi as Christ wont make I boast, instead, I dey tok like fool.
2CO 11:18 Since some pipol dey boast like dis world pipol, make mi mysef still boast.
2CO 11:19 Una sey una get sense well-well, yet una dey use happiness asept wetin fool dey tok.
2CO 11:20 Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.
2CO 11:21 (Na shame for mi, but I must tell una sey awa heart nor strong rish to do una doz kind tins!) But anytin wey anybody fit boast about (I dey tok like fool naw o-o), misef fit boast about dat tin too.
2CO 11:22 Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.
2CO 11:23 Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times.
2CO 11:24 Na five times Jew pipol don flog mi thirty-nine times.
2CO 11:25 Rome pipol don beat mi three times. Dem stone mi wons until I nearly die. Sheep wey I dey inside, don spoil for wota three times. I don float wons for wota from morning go rish di next day.
2CO 11:26 I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.
2CO 11:27 I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body.
2CO 11:28 Apart from dis tins, my mind dey heavy mi evriday as I dey tink of how I go take help all di pipol wey dey God church.
2CO 11:29 If pesin dey weak, misef dey weak too. If dem deceive pesin enter sin, e dey pain mi well-well.
2CO 11:30 If I go must boast, den I go boast about di tins wey show sey I dey weak.
2CO 11:31 God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok.
2CO 11:32 For Damaskus, King Aretas sey make di govnor put sojas for di town gate, so dat dem go arrest mi.
2CO 11:33 But awa pipol for der kon put mi for basket wey dem tie rope put kon drop mi small-small from di window and na so I take eskape from di man hand.
2CO 12:1 E good to dey boast, even doh gain nor dey inside. I go still dey tok about di vishon and revelashon wey Jesus Christ show mi.
2CO 12:2 Fourteen years ago, I know one man wey bi Christ savant. Weda na for vishon or Fisical, I nor know, but God know. God karry am go di heaven wey high pass.
2CO 12:3 And I know dis man (but na only God know weda e dey for en body or for spirit).
2CO 12:4 God karry am go paradise and e hear tins wey dey too holy to tok; tins wey God nor give human being pawa to tok.
2CO 12:5 Na dat pesin make mi dey boast and I nor go boast about mysef, escept di tins wey show sey, I nor dey strong.
2CO 12:6 Even if I won boast, I nor go bi fool, bikos na trut I go still tok, but I nor do am make anybody for tink sey na mi know pass, bikos e si and hear mi dey tok
2CO 12:7 about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi.
2CO 12:8 Na three times I ask Christ sey, make e take dis tin komot from my body.
2CO 12:9 But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.
2CO 12:10 I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.
2CO 12:11 I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi.
2CO 12:12 True-true for una present, wi do mirakles and wonders to show sey wi bi apostles too.
2CO 12:13 Bikos di way wey dem trit us worse pass di oda church, escept sey I nor dey put my load for una head. Make una forgive mi for dis tins wey I do!
2CO 12:14 Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.
2CO 12:15 I go dey happy to spend all my money and even my life, as long as una soul go dey save. Una love for mi dey small, bikos my love for una plenty?
2CO 12:16 Even if e bi like dat, I nor put my load for una head. But dem sey, bikos I bi wayo pesin, I dey deceive una!
2CO 12:17 I nor play anybody wayo thru di pesin wen I send kom meet una, abi I dey lie?
2CO 12:18 Abeg Titus make e visit una and I send dat broda make e follow am kom. Dem play una wayo? Nor bi di same mind wi awasef take follow una? Abi nor bi di same way wi dey bihave?
2CO 12:19 May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.
2CO 12:20 Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
2CO 12:21 I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
2CO 13:1 Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.
2CO 13:2 Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,
2CO 13:3 bikos una sey make I show sey Christ dey tok thru mi. Christ nor dey weak to una, bikos e show en pawa among una.
2CO 13:4 True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.
2CO 13:5 Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!
2CO 13:6 I hope sey una go know sey wi neva fail di test!
2CO 13:7 Wi dey pray to God make una nor do anytin bad; wi nor dey do am to show sey wi pass di test, but make una for do wetin good, even if e bi like sey wi fail di test.
2CO 13:8 Wi nor go fit do anytin against di trut, but na di trut go make us do evritin.
2CO 13:9 Belle dey sweet us wen ever wi dey weak and una dey strong. And na wetin wi dey pray for bi dis, “Una go get evritin wey una suppose get.”
2CO 13:10 Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.
2CO 13:11 Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.
2CO 13:12 Make una greet each oda for Christian way.
2CO 13:13 All God pipol for here dey greet una.
2CO 13:14 Make di grace wey awa Oga God Jesus Christ give us and di love wey God get for us, plus di Holy Spirit fellowship, dey with una.
GAL 1:1 Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat).
GAL 1:2 Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia.
GAL 1:3 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una.
GAL 1:4 Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am.
GAL 1:5 Make all glory bi en own forever and ever! Amen.
GAL 1:6 I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing.
GAL 1:7 Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ.
GAL 1:8 But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire!
GAL 1:9 As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell!
GAL 1:10 Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
GAL 1:11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi.
GAL 1:12 Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.
GAL 1:13 Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am.
GAL 1:14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons.
GAL 1:15 But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi.
GAL 1:16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi
GAL 1:17 and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.
GAL 1:18 Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days.
GAL 1:19 But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda.
GAL 1:20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true!
GAL 1:21 Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria.
GAL 1:22 But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi.
GAL 1:23 Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.”
GAL 1:24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.
GAL 2:1 Afta fourteen years, I kon go back to Jerusalem with Banabas and Titus.
GAL 2:2 I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.
GAL 2:3 Titus dey with mi; even doh en na Greek pesin, dem nor sey e must sekonsaiz.
GAL 2:4 Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave.
GAL 2:5 But wi nor give dem shance, so dat di trut wey dey di gospel, go last for una.
GAL 2:6 But doz wey tink sey dem bi oga, (wetin dem bi, nor mean anytin to mi; bikos God nor dey support bad tin); dem wey bi leaders for di church nor add anytin to my message.
GAL 2:7 But dem kon si sey na God sey make I prish en word to pipol wey dem nor sekonsaiz, just as E sey make Pita prish to doz wey dem sekonsaiz,
GAL 2:8 (Bikos na thru God pawa Pita take prish to Jew pipol and na di same pawa I take dey prish give Gentile pipol too),
GAL 2:9 so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”
GAL 2:10 But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.
GAL 2:11 But wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e do, nor good.
GAL 2:12 Pita dey chop with Gentile pipol until some pipol wey James send, kom rish der. As Pita si dem, e kon stop to chop with Gentile pipol, bikos e dey fear di pipol wey kom, since dem bilive sey evribody must sekonsaiz.
GAL 2:13 Oda Jew pipol kon dey pritend like Pita, sotey Banabas join dem too.
GAL 2:14 But wen I si sey dem nor dey do wetin dem rite for God word, I kon tell Pita for dia front, “If yu wey bi Jew, dey do like Gentile pipol, how yu wont take make Gentile pipol live like Jew pipol?”
GAL 2:15 Wi bi Jew pipol bikos of how dem born us and wi nor bi Gentile pipol wey bi sinnas.
GAL 2:16 Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.
GAL 2:17 Make wi dey kommit sin as wi dey try to do good, bikos wi get faith for Christ? If na so, dat mean sey Christ don dey support sin!
GAL 2:18 Naw, if I dey ripair di law wey I don first skata, dat mean sey I dey break God law.
GAL 2:19 As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.
GAL 2:20 I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.
GAL 2:21 I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!
GAL 3:1 Galatia pipol, una nor get sense at-all! Who turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jesus Christ die for cross!
GAL 3:2 Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una?
GAL 3:3 Na so una mumu rish? True-true, una start with di Holy Spirit, but naw, una won finish di work with human being pawa.
GAL 3:4 Una sofa dis many tins for nor-tin? True-true, una really sofa for nor-tin.
GAL 3:5 Wetin make God give una di Spirit to do mirakle? Na bikos una do wetin di law tok or bikos una bilive wetin una hear?
GAL 3:6 Just as Abraham bilive God and God koll am raitious man,
GAL 3:7 na so too, doz wey bilive, go bi Abraham shidren.
GAL 3:8 Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.”
GAL 3:9 So pipol wey bilive, God go bless dem togeda with Abraham, bikos dem bilive.
GAL 3:10 Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”
GAL 3:11 Dis one show sey, nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. So anybody wey dey raitious, must live by faith.
GAL 3:12 Di law nor dey bring faith, but di pesin wey dey do wetin di law tok, go live by wetin e dey do.
GAL 3:13 Christ don save us from di curse wey di law bring, bikos e die for cross for us (just as dem rite am, “Anybody wey dem hang for tree, curse dey en head”),
GAL 3:14 so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.
GAL 3:15 My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am.
GAL 3:16 Wi know sey God make dis promise with Abraham and en pikin. God word nor sey, “to di shidren”, but e sey, “and to yor pikin,” and e mean only one and dat one, na Christ.
GAL 3:17 Na wetin I dey tok bi dis: Di law wey kom afta four hundred and thirty years, nor get pawa to break di agriment and promise wey God and Abraham don make before.
GAL 3:18 Bikos if promise dey kom thru di law, den e nor bi promise again. But wi know sey, na thru promise, God take bless Abraham.
GAL 3:19 Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.
GAL 3:20 Wi know sey pesin wey bi middo-man dey stand between two pipol, but na only one God dey.
GAL 3:21 So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law.
GAL 3:22 But God word kondemn evritin and evribody under sin, so dat wi; di pipol wey bilive, go get God promise thru Jesus Christ.
GAL 3:23 Before faith kom, wi dey under di law, bikos di law whole us like prisonas.
GAL 3:24 So na di law bi awa tisha before Christ kom, so dat wi go fit tok sey wi dey raitious thru faith.
GAL 3:25 But since faith don kom, wi nor dey under any tisha again.
GAL 3:26 Bikos thru Jesus Christ, all of us don bikom God shidren by faith.
GAL 3:27 Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot.
GAL 3:28 E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ.
GAL 3:29 And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.
GAL 4:1 Wetin I mean bi sey, di pesin wey inherit en papa propaty and e still bi small pikin, e nor dey difren from savant, even doh na en get evritin.
GAL 4:2 But e go dey under who dey guide am, until di time wey en papa tok, go rish.
GAL 4:3 Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world,
GAL 4:4 but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law,
GAL 4:5 make e save pipol wey dey under di law, so dat God go make us en own shidren kon give us awa own propaty.
GAL 4:6 Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!”
GAL 4:7 So, una nor bi slave again, but una don bi God pikin and since una bi God shidren, una go get God propaty too.
GAL 4:8 Before-before, wen una nor know God, una dey do bad-bad tins.
GAL 4:9 But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?
GAL 4:10 Dat time, una follow dia tradishon.
GAL 4:11 I dey fear sey make di work wey I do among una, nor waste.
GAL 4:12 My brodas and sistas, Abeg, make una bi like mi, as I don bi like una, bikos una nor do mi any bad tin!
GAL 4:13 But wen I first prish di gospel give una, una know sey I nor well,
GAL 4:14 even doh my sickness na problem to una, una nor laf or drive mi. Instead, una welkom mi like God angel; like sey na mi bi Jesus Christ!
GAL 4:15 Naw, na wetin don happen to una happiness? I know sey, if to sey e dey possibol, una for pul una eye give mi!
GAL 4:16 So, I don bikom una enemy, bikos I dey tell una di trut?
GAL 4:17 Di pipol wey won deceive una dey trit una well, but dem nor dey do am with betta mind; bikos dem wont make una leave mi kon follow dem.
GAL 4:18 But e good make una dey trit odas well, so-far una dey do am with betta mind and nor bi only wen I dey with una.
GAL 4:19 My shidren! Just like woman wey won born, I dey feel pain for una, until Christ pawa go dey inside una life!
GAL 4:20 How I wish sey I dey with una naw, so dat I go know how to trit una, bikos I dey worry about una well-well.
GAL 4:21 Make una tell mi, wish of una won dey under di law? Una nor know wetin di law tok?
GAL 4:22 Dem rite am sey, Abraham get two boys, one wey di savant woman born and di oda pikin, na di really wife born am.
GAL 4:23 Di one wey savant born, na ordinary pikin e bi, but na thru God promise di really wife take born.
GAL 4:24 Betta sense dey for dis story, bikos dis two wimen bi like two kovenant. One na from Mount Sinai wey bi like di shidren wey Hagar, di slave woman, born.
GAL 4:25 Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.
GAL 4:26 But di Jerusalem wey kom from heaven, dey free and na-im bi awa mama.
GAL 4:27 Bikos dem rite am sey: “Woman! Yu wey neva born, make yu shaut dey happy, bikos yu neva labor like woman wey won born. Di woman wey neva born, get plenty shidren pass di woman wey get husband.”
GAL 4:28 But my brodas and sistas, una bi shidren wey get promise, just as Isaak bi.
GAL 4:29 For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw.
GAL 4:30 But wetin dem rite for God word? “Make yu drive di savant woman and en pikin komot, bikos di savant pikin nor go share with di pikin wey di really wife born.”
GAL 4:31 So my brodas and sistas, wi nor bi savant shidren. Na di really woman shidren, wi bi.
GAL 5:1 Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
GAL 5:2 Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again.
GAL 5:3 And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok.
GAL 5:4 Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace.
GAL 5:5 Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye.
GAL 5:6 For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
GAL 5:7 Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut?
GAL 5:8 Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis!
GAL 5:9 Na small yist dey make bread raiz!
GAL 5:10 I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi.
GAL 5:11 Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol.
GAL 5:12 I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!
GAL 5:13 My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.
GAL 5:14 Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
GAL 5:15 But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake.
GAL 5:16 I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.
GAL 5:17 Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont.
GAL 5:18 But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again.
GAL 5:19 Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol;
GAL 5:20 to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;
GAL 5:21 bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
GAL 5:22 But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,
GAL 5:23 gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.
GAL 5:24 Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.
GAL 5:25 If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont.
GAL 5:26 Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.
GAL 6:1 My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.
GAL 6:2 Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.
GAL 6:3 Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef.
GAL 6:4 Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.
GAL 6:5 Bikos each pesin go karry en own load by ensef.
GAL 6:6 Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am.
GAL 6:7 Make una nor let anybody deceive una. Nobody go fit deceive God. Anytin wey pesin plant, naim e go reap,
GAL 6:8 bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.
GAL 6:9 So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am.
GAL 6:10 So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.
GAL 6:11 Make una si as di word wey I take my hand rite give una, big rish!
GAL 6:12 Pipol wey won show sey dem good, dey try to force una to sekonsaiz. Dem dey do so, so dat dem nor go sofa, bikos of Christ cross.
GAL 6:13 Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast.
GAL 6:14 I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.
GAL 6:15 Weda pesin sekonsaiz or not, e nor mean anytin, di only tin wey matter bi sey, una don turn to new pesin.
GAL 6:16 Una wey dey obey dis rule wey I dey give so, make peace and mesi dey with una and all God pipol.
GAL 6:17 From naw go, make nobody worry mi, bikos I get Jesus Christ mark for my body.
GAL 6:18 My brodas and sistas, make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit. Amen!
EPH 1:1 Dis leta na from Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efesus, di ones wey dey follow Jesus Christ with faith.
EPH 1:2 Make di grace and peace wey dey kom from God awa papa and from awa Oga God Jesus Christ, dey with una.
EPH 1:3 I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
EPH 1:4 Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.
EPH 1:5 Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.
EPH 1:6 So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.
EPH 1:7 Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.
EPH 1:8 Di grace wey E give us, get plenty wisdom, sense and undastandin.
EPH 1:9 E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.
EPH 1:10 God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.
EPH 1:11 All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,
EPH 1:12 so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.
EPH 1:13 Since una don hear di trut kon bilive Christ, God don give una di Holy Spirit as special mark to show sey naim get una.
EPH 1:14 God deposit dis Holy Spirit for di tins wey wi go inherit, until di time wen E go save en pipol, so dat all praiz and glory go bi en own.
EPH 1:15 So, since I hear about una faith for Christ and how una love all God pipol,
EPH 1:16 I nor dey stop to tank God for una, wen ever I dey pray.
EPH 1:17 I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.
EPH 1:18 Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.
EPH 1:19 Una don si how en pawa big rish, bikos una bilive am. Dis na di pawa wey dey do big-big tins for us.
EPH 1:20 E show dis pawa thru Christ, wen E raiz am from deat, kon make am sidan for en rite hand for heaven;
EPH 1:21 di place wey far well-well, wey high pass where wiked pipol dey rule; wey strong pass evry pawa wey dey dis world; big pass evry name wey dey for dis world and di ones wey dey kom.
EPH 1:22 God put evritin under Christ leg kon make am head for di church and Oga God for evritin.
EPH 1:23 Na di church bi Christ body and naim dey make evritin for evriwhere full and komplete.
EPH 2:1 Before-before, na sturbones and sin dey kontrol una life,
EPH 2:2 bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren.
EPH 2:3 All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.
EPH 2:4 Bikos God love us well-well, E don show us plenty mesi
EPH 2:5 (aldo sin dey kontrol awa life before), E kon give us life thru Christ, den E save us with en grace!
EPH 2:6 E raiz us up with Christ kon make us sidan with am for heaven.
EPH 2:7 E do dis, to show evribody for di world wey dey kom sey, en grace wey dey show us kindness thru Jesus Christ, big well-well.
EPH 2:8 God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una.
EPH 2:9 E nor save una bikos of di work wey una do, so make nobody dey boast.
EPH 2:10 God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.
EPH 2:11 Make una remember sey before-before una bi Gentile pipol wey dey do wetin di flesh wont and Jew pipol dey koll una, “pipol wey dem neva sekonsaiz” like di way dem dey sekonsaiz human being.
EPH 2:12 Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.
EPH 2:13 But thru Jesus Christ blood, una wey bin dey far, God don draw una near ensef,
EPH 2:14 bikos na Christ bi awa peace. Na Christ make Jew and Gentile pipol bi one. E don break di wall wey divide and separate dem as enemies.
EPH 2:15 E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem.
EPH 2:16 E use di sofa wey e sofa for cross take end dia kworel kon make dem one body as dem dey serve God.
EPH 2:17 And e prish peace to una wey dey far and near,
EPH 2:18 so dat thru am, all of us with one Spirit, go fit rish where awa Papa dey for heaven.
EPH 2:19 So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Israel blessings again, but una go bi God shidren with all di pipol wey dey en house.
EPH 2:20 Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.
EPH 2:21 Na for inside Christ di whole building for join togeda kon grow as one holy Temple for God and
EPH 2:22 thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.
EPH 3:1 Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.
EPH 3:2 True-true, una don hear sey na God give mi dis work thru en grace and na for una own good.
EPH 3:3 God open my eye to undastand en sekret, as I rite to una before,
EPH 3:4 so dat wen una read am, una go fit undastand di sekret wey God show mi.
EPH 3:5 Di pipol wey dey before nor know dis sekret as God don show en holy apostles and profets wey dey naw, thru di Holy Spirit.
EPH 3:6 So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise.
EPH 3:7 I bi dis gospel savant, bikos of God grace wey E give mi thru di work wey en pawa dey do.
EPH 3:8 Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.
EPH 3:9 Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world.
EPH 3:10 E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
EPH 3:11 Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ
EPH 3:12 and na bikos Christ dey faithful, naim make us get di heart to fit rish where God dey.
EPH 3:13 Na dis make mi tell una sey, make una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own good.
EPH 3:14 Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front,
EPH 3:15 where all di family for heaven and eart from get dia names.
EPH 3:16 I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una.
EPH 3:17 So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,
EPH 3:18 una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish.
EPH 3:19 Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.
EPH 3:20 So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.
EPH 3:21 Make all glory for Christ church bi en own from one generashon go rish anoda. Amen!
EPH 4:1 Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.
EPH 4:2 Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get.
EPH 4:3 Make una dey do evritin wey una fit do to keep di unity wey di Spirit dey give, as una dey live togeda for peace.
EPH 4:4 Na one body and Spirit dey, bikos just as all of una get one hope from God wen E koll una,
EPH 4:5 na so too una get one Oga God, one faith, one baptizim,
EPH 4:6 one God and Papa wey dey above evribody; dey use evribody and dey inside evribody.
EPH 4:7 But God don give grace to all of us akordin to how Christ gift plenty rish.
EPH 4:8 Na dis make dem sey, “Wen e raiz-up go heaven, E karry many prisonas wey E free follow body and E give plenty gift to pipol.”
EPH 4:9 Na wetin dis word, “E raiz-up,” mean? E mean sey Christ first die and dem beri am for di eart.
EPH 4:10 En wey dem beri, naim still bi di pesin wey raiz-up pass di heavens, so dat e go komplete evritin.
EPH 4:11 Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.
EPH 4:12 Christ do like dis to prepare us for di ministry work, wey go make God church grow,
EPH 4:13 so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ.
EPH 4:14 So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
EPH 4:15 But, as wi dey do wetin dey good and korrect with love, wi go dey grow for evry side kon meet Christ wey bi di head.
EPH 4:16 Na from Christ di whole body dey grow well and join togeda thru di pawa wey dey support am. As each part dey do en work, na so di body go dey grow inside God love.
EPH 4:17 So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense.
EPH 4:18 Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.
EPH 4:19 Dem dey do wayo, dey give dia body to yeye tins; tins wey nor dey pure and dey wiked.
EPH 4:20 But wi nor tish una like dat about Christ.
EPH 4:21 If na thru, den una don hear and learn di trut about am, just as di trut dey inside Christ.
EPH 4:22 Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins
EPH 4:23 and make una dey tink betta tins for una mind.
EPH 4:24 Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
EPH 4:25 Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.
EPH 4:26 If una dey vex, make una nor sin and make day nor dark still meet una dey vex.
EPH 4:27 Make una nor give di devil any shance.
EPH 4:28 Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.
EPH 4:29 Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.
EPH 4:30 Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.
EPH 4:31 Una must stop to get bad belle; to dey vex; kworel and to dey tok bad-bad word.
EPH 4:32 Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.
EPH 5:1 So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well.
EPH 5:2 Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.
EPH 5:3 To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol.
EPH 5:4 Make una nor allow yeye and foolish word kom out from una mout. And make una nor dey tok anyhow or use bad word, bikos all dis tins nor good. Instead, make una dey tank God with una mout.
EPH 5:5 One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.
EPH 5:6 Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.
EPH 5:7 So make una nor join dem.
EPH 5:8 Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite,
EPH 5:9 bikos di fruit wey lite get, dey bring goodness, raitiousness and trut.
EPH 5:10 So, make una always dey do tins wey go make God happy.
EPH 5:11 Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.
EPH 5:12 Shame nor go let wiked pipol tok about wetin dem dey do for sekret.
EPH 5:13 But evribody go si evritin wey kom out for lite.
EPH 5:14 Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
EPH 5:15 Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.
EPH 5:16 Make una use evry shance wey una get well, bikos dis time wey wi dey so, dey evil and wiked.
EPH 5:17 Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean.
EPH 5:18 Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.
EPH 5:19 Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.
EPH 5:20 With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.
EPH 5:21 Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.
EPH 5:22 Una wey bi wife, make una dey respet una husband, just as una dey respet Christ,
EPH 5:23 bikos na di husband bi di wife head, just as Christ bi head for di church and naim en save di body.
EPH 5:24 As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin.
EPH 5:25 Husband, make una love una wife, just as Christ love di church kon sakrifice en life for am,
EPH 5:26 so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word.
EPH 5:27 E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am.
EPH 5:28 Na so too, husbands suppose love dia wife like dia own body. Man wey love en wife, love ensef.
EPH 5:29 Nobody don ever hate e own body, but e dey feed and kare for am, just as Christ dey kare for di church,
EPH 5:30 bikos wi bi part for en body.
EPH 5:31 Na bikos of dis, man go live en papa and mama go join en wife and di two of dem, go bi one flesh.
EPH 5:32 Dis sekret wey I dey tell una so big well-well, but na di tin wey dey between Christ and di church, I dey tok about.
EPH 5:33 So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.
EPH 6:1 Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
EPH 6:2 Make una respet una papa and mama, bikos na dis bi di first kommandment from God wey get promise.
EPH 6:3 So dat e go betta for una and una go get long life.
EPH 6:4 Una wey bi papa, make una nor make una shidren vex, but make una raiz dem to follow Christ tishing.
EPH 6:5 Una wey bi savant, make una dey obey una masta with fear, respet and with klean mind like sey, na Christ una dey obey.
EPH 6:6 Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart.
EPH 6:7 Make una dey do una work with betta mind like sey, na Christ una dey do am for and nor bi human being,
EPH 6:8 bikos una know sey, each pesin; weda e bi slave or e dey free, if e do wetin dey good, Christ go reward am.
EPH 6:9 And una wey bi masta, make una dey trit una savant well. Make una nor make dem fear, bikos both yu and dem get di same masta for heaven and E nor dey favor pesin anyhow.
EPH 6:10 Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
EPH 6:11 Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use.
EPH 6:12 Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.
EPH 6:13 Na dis make mi sey, make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go still stand well.
EPH 6:14 So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body.
EPH 6:15 Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace
EPH 6:16 and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow.
EPH 6:17 Make una wear salvashon like priest kap for head kon whole di Spirit swod wey bi God word.
EPH 6:18 With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.
EPH 6:19 Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.
EPH 6:20 I bi God messenja, even doh I dey for prison naw. But make una pray sey, I go dey tok with boldness as I suppose to tok.
EPH 6:21 Tikikus wey bi my special broda and faithful savant for God work, go tell una evritin, so dat una go know wetin dey happen to mi for here.
EPH 6:22 Na bikos of dis I send am kom meet una, make una for know how tins dey with us for here and make e for fit enkourage una heart.
EPH 6:23 I pray sey make God, awa Papa and Oga God Jesus Christ give all my fellow Christian brodas and sistas peace, love and faith.
EPH 6:24 Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.
PHI 1:1 Dis leta na from Paul and Timoti, wey bi Jesus Christ savant. To all God pipol for Filippi, with dia bishops and leaders.
PHI 1:2 Make God awa papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
PHI 1:3 I dey tank my God evritime I remember una.
PHI 1:4 Evritime wen I dey pray for una, I dey do am with happiness,
PHI 1:5 bikos of how una dey help mi prish di gospel from di first day wey una hear am kon rish today.
PHI 1:6 I dey sure sey, di Pesin wey start dis good work for una life, go make am pafet until di day wen Christ go kom.
PHI 1:7 So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.
PHI 1:8 God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.
PHI 1:9 I pray make una love dey strong more-more for God tins wey una learn and make E help una undastand,
PHI 1:10 so dat una go fit choose wetin betta pass and as una dey do so, una go dey ready for di day wen Christ go kom.
PHI 1:11 Make di work wey Christ do for us and how to please God, full una mind. Den all di glory and praiz go bi God own.
PHI 1:12 My brodas and sistas, I wont make una know sey my sofa na to make di gospel stand.
PHI 1:13 Di sojas wey dey guide di prison and all di oda pipol don know sey, na bikos of Christ, I dey prison
PHI 1:14 and bikos of di prison wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas faith for Christ, don strong well-well. And naw, dem don dey prish God word without fear.
PHI 1:15 True-true, na jealousy and kworel make some dey prish about Christ, but odas dey do am with betta mind.
PHI 1:16 I know sey dis ones na love make dem dey do am, bikos dem know sey I dey here to defend wetin dem dey prish.
PHI 1:17 Doz oda ones wey dey prish about Christ dey do so, bikos dem dey tink about diasef and wetin dem go gain. Dem nor dey do tins with klean mind and dem tink sey dem fit kause more trobol for mi, bikos I dey prison.
PHI 1:18 But dat one nor matter to mi. So, weda dem dey pritend or do am with klean mind, di message about Christ dey kontinue and na dat one dey make mi happy. I go always dey happy,
PHI 1:19 bikos I know sey na una prayer and di help wey Christ Spirit dey give, dey save mi.
PHI 1:20 Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
PHI 1:21 Bikos to mi, to dey dis life, na to live for Christ and to die inside Christ, na dat one betta pass.
PHI 1:22 If I kontinue to dey live inside dis body, e mean sey I go do betta work, but I nor know wish one I go like pass.
PHI 1:23 Naw, I know wish one I go choose, bikos I won go dey with Christ and na dat one betta pass.
PHI 1:24 But e go good for una as I still dey for dis body.
PHI 1:25 I dey sure of dis tins: I know sey I nor go die naw, so dat I go kontinue with una and as una dey inside di faith, una life go dey betta more-more.
PHI 1:26 So wen I kom meet una again as una dey serve Christ, una go get more rizin to dey happy bikos of mi.
PHI 1:27 Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.
PHI 1:28 Make una nor fear una enemies, bikos dem go soon skata and dat na sign to show sey God go save una.
PHI 1:29 God don give una dis sign, nor bi only make una for bilive Christ, but make una for still sofa for am,
PHI 1:30 bikos una dey face di same sofa wey una si mi dey face. And I wont make una know sey, even naw, I still dey sofa di same tin.
PHI 2:1 Gain dey to serve Christ? Konfort dey for en love? Fellowship dey between pipol and God Spirit? Una heart good rish to show pipol mesi?
PHI 2:2 Den, make una let my joy dey komplete, as una dey gri with each oda and dey love and work togeda with one mind.
PHI 2:3 Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.
PHI 2:4 Make una nor dey tink about unasef alone and wetin una wont, but make una dey tink about wetin good for odas too.
PHI 2:5 Make una get di same mind wey Christ get:
PHI 2:6 wey bi sey, even doh en with God na di same, e nor boast about am.
PHI 2:7 But e leave evritin wey e get for heaven kon bi like savant. So e kom dis world as human being.
PHI 2:8 E put en body down kon obey God, until Jew pipol kill and nail am for cross!
PHI 2:9 Bikos of dis, God raiz am up kon gi-am di name wey big pass evry oda name,
PHI 2:10 so dat wen dem koll Jesus name, evribody and evritin must knee down, weda dem dey heaven, eart or for under di eart
PHI 2:11 and evry tongue go konfess sey, “Na Jesus Christ bi di Oga God.” Den all di glory go bi God own.
PHI 2:12 So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,
PHI 2:13 bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy.
PHI 2:14 Make una nor use vexnashon take work for God,
PHI 2:15 so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars,
PHI 2:16 bikos una get God message wey dey give life. So, di day wen Christ go kom, I go get rizin to boast sey I nor run dis race or work for nor-tin.
PHI 2:17 But even if dem take mi offa sakrifice for una, I go dey happy,
PHI 2:18 so make una kom follow mi rijoice.
PHI 2:19 As Jesus Christ wont am, I go send Timoti kom meet una, so dat my heart go strong small, with di news wey I go hear about una.
PHI 2:20 Among all di pipol for here, na only Timoti get di kind mind wey I get for una and naim dey make mi tink of una and how una dey manage.
PHI 2:21 Di odas dey busy with dia own matter, but nor bi matter wey koncern Christ.
PHI 2:22 Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.
PHI 2:23 I go soon send am kom meet una, so dat una go know how my kondishon bi.
PHI 2:24 Aldo I bilive Christ sey, e nor go tey, before mi mysef go kom visit una.
PHI 2:25 But before dat time, I don tink am sey, e good make I send Epafroditus kom meet una. En na my broda, ko-worker and soja. Na una messenja e bi and e dey help mi anytime wey I nid anytin.
PHI 2:26 True-true, e miss all of una well-well and en mind dey worry am, bikos una hear sey e nor well.
PHI 2:27 E sick well-well sotey e nearly die. But God get mesi for am; nor bi only for am, but for mi too, so dat I nor go kry join di one wey I dey so.
PHI 2:28 Na dis make mi won really send am kom meet una, so dat wen una si am, belle go sweet una again and I nor go dey worry about una.
PHI 2:29 So make una welkom and respet am as una broda for Christ with happiness,
PHI 2:30 bikos e nearly die bikos of Christ. E put en life for danger, so dat e go fit help mi do wetin una for do, since una nor dey here.
PHI 3:1 Finally, my brodas and sistas, make una happy bikos una get Christ. I dey rite di same tin give una again, bikos e go help una.
PHI 3:2 Make una shine una eye, bikos of doz wey dey bihave like dogs and wiked pipol wey dey ponish dia body!
PHI 3:3 Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.
PHI 3:4 Aldo my own rizin important too. If anybody tink sey e get betta rizin to put hope for wetin human being dey do, mi Paul, get pass dem.
PHI 3:5 Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.
PHI 3:6 Bikos I really won do God work, I kon dey kause sirious wahala for di pipol wey dey di church. I do evritin just as di law sey make wi do, so dat wi go dey good for God eye. So, I nor get any fault.
PHI 3:7 But all dis tins wey I si as gain, I kon kount dem to bi nor-tin bikos of Christ.
PHI 3:8 Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,
PHI 3:9 kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.
PHI 3:10 Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die,
PHI 3:11 so dat mi too go still wake-up from deat, as e wake.
PHI 3:12 Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.
PHI 3:13 My brodas and sistas, I nor look mysef like sey I don get evritin wey I wont. Bikos I dey tink of only one tin wey bi: To forget di tins wey don pass kon dey porshu di ones wey dey front
PHI 3:14 and as I put my mind for dis tins, I dey try to get di prize wey bi life for heaven; prize wey make God koll us thru en pikin, Jesus Christ.
PHI 3:15 So wi wey don mature for Christ, make wi get dis kind mind. But if una dey tink difren tins, I bilive sey God go show una di trut.
PHI 3:16 So, make wi kontinue to follow di rules wey wi dey follow.
PHI 3:17 My brodas and sistas, make una dey live like mi and dey learn from odas wey dey follow us as ezample.
PHI 3:18 Bikos I don tell una before and I dey tok am again with tears for my eye sey, di way many pipol dey bihave, dey show sey dem bi enemies to Christ cross.
PHI 3:19 Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.
PHI 3:20 But wi bilong to heaven and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga God Jesus Christ.
PHI 3:21 E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
PHI 4:1 My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!
PHI 4:2 I dey beg Euodia and Sintike make dem gri togeda inside Christ.
PHI 4:3 Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
PHI 4:4 Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!
PHI 4:5 Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom.
PHI 4:6 Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
PHI 4:7 Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.
PHI 4:8 Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
PHI 4:9 So anytin wey una learn, hear and si mi dey do, make una dey do dem too. And di God wey dey give us peace, go dey with una.
PHI 4:10 I dey happy well-well inside Christ, bikos una don finally show sey, una dey tink about how I dey manage. (I know sey una get mi for mind before, but una nor get shance to do anytin for mi).
PHI 4:11 I nor dey tok dis one bikos I nid anytin, but na bikos I don learn to dey okay for any kondishon wey I si mysef.
PHI 4:12 E get sometaim wey I nor get and sometaim, I dey get plenty. But for evry kondishon, I don learn how to dey okay, weda my belle full or I dey hongry; weda I get plenty or I nor get anytin at-all.
PHI 4:13 I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.
PHI 4:14 But una try well-well as una help mi wen I dey trobol.
PHI 4:15 Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.
PHI 4:16 Bikos even for Tesalonika, una still send tins kom give mi.
PHI 4:17 I nor dey tok dis bikos I wont gift, but make una for gain from dis work wey una dey do.
PHI 4:18 Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don give mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey make belle sweet God.
PHI 4:19 My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ.
PHI 4:20 Make evribody give glory to God awa Papa, forever and ever. Amen.
PHI 4:21 Make una greet God pipol wey dey for Christ.
PHI 4:22 God pipol wey dey here dey greet una too, especially doz ones wey kom from Caesar house.
PHI 4:23 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit.
COL 1:1 Dis leta na from mi Paul, Jesus Christ apostle and Timoti my broda, bikos na so God wont am.
COL 1:2 To all God pipol for Kolosse, wey bi awa brodas and sistas for Christ. Make God awa Papa give una grace and peace.
COL 1:3 Wi dey always tank God wey bi Jesus Christ Papa, anytime wen wi dey pray for una,
COL 1:4 since wi hear about how una bilive Christ and di love wey una get for God pipol.
COL 1:5 Wen una first hear about di Good News wey bring trut, una kon get love and faith for wetin God prepare for una for heaven and na dis gospel
COL 1:6 kom meet una. Dis gospel dey bear fruit for di whole world and since di day wey una hear am, una don undastand as God grace big rish and e don dey bear fruit and grow among una.
COL 1:7 Awa broda Epafras, wey dey work for Christ with all en mind, even doh wi nor dey der, na-im tish una di gospel
COL 1:8 and e kon tell us about di love wey di Spirit give una.
COL 1:9 Bikos of dis, wi too, since wi hear about una, wi neva stop to dey pray for una. Wi dey tell God make E show una wetin E wont, so dat una go dey wise and undastand God Spirit,
COL 1:10 den una life go betta just as Christ wont. For all di good tins wey una dey do, make una dey bear fruit and learn to know God more-more.
COL 1:11 Wi still dey pray sey una go dey strong with God pawa wey get glory. Una go show sey una dey patient and get strong mind for God work with happiness.
COL 1:12 Make una dey tank God, bikos E don make una share from wetin en pipol get for en kingdom wey dey give lite.
COL 1:13 E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.
COL 1:14 Dis na di pikin wey pay for us, so dat wi go dey free and God go forgive us awa sins.
COL 1:15 God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.
COL 1:16 Bikos God kreate evritin for heaven and eart thru en pikin; both Fisical and spiritual tins; weda dem get pawa or dey rule for difren-difren place; God kreate dem thru am and E kreate dem for am.
COL 1:17 Christ dey before evritin and bikos e dey, evritin still dey where dem dey.
COL 1:18 Na-im bi head for di body wey bi di church and from di biginnin, na-im bi di first-born wey raiz-up from grave, so dat e go bi nomba one for evritin.
COL 1:19 God dey happy sey evritin wey dey inside am, dey inside en pikin too
COL 1:20 and thru Christ blood wey e pour out for us for di cross, God go draw evritin back to ensef afta E don make peace with tins for heaven and eart.
COL 1:21 Before-before, bikos of di wiked tins wey una dey do and tink, una dey far from God and una bi en enemy.
COL 1:22 But naw, with en pikin blood, E don draw una klose kom en present, so dat E go make una en friends wey nor get stain or fault and wey dey holy.
COL 1:23 If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.
COL 1:24 I dey happy for di sofa wey I dey sofa for una and for di church wey bi Christ body, so I dey take my body komplete wetin remain for Christ sofa.
COL 1:25 I bi savant for di church, bikos of di work wey God sey make I do for una and I dey do am to komplete God work.
COL 1:26 So di sekret wey E hide from awa grand-grand papa dem and evribody wey dey di world before, E don open am make en pipol si.
COL 1:27 God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.
COL 1:28 As wi dey tell evribody wetin dem go do, wi dey prish Christ and tish with wisdom, so dat wen wi go show una to Christ, una go don dey pafet.
COL 1:29 So na dis tins I dey struggol and work for akordin to en pawa wey dey work inside mi.
COL 2:1 Pipol for Laodicea and doz wey neva si mi face-to-face, I wont make una know how I dey work for una rish.
COL 2:2 Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
COL 2:3 Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem inside Christ.
COL 2:4 I dey tok all dis tins, so dat nobody go dey deceive una with argument.
COL 2:5 And even if I nor dey der with una, my spirit dey der and I dey happy sey una mind nor dey shange and una faith for Christ, still strong well-well.
COL 2:6 So, just as una asept Jesus Christ as una Oga God, make una kontinue to live una life inside am.
COL 2:7 Make una dey strong for groun and dey grow inside Christ, so dat una faith go strong as wi dey tish una and una go dey tank God well-well.
COL 2:8 Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
COL 2:9 Bikos na Christ dey show us evritin about God.
COL 2:10 And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.
COL 2:11 Dem sekonsaiz una inside am. Dis nor bi human being sekonsishon, but na di spirit own wey Christ dey do.
COL 2:12 Bikos wen dem baptize una, dem beri una with am and una follow am raiz-up thru di faith wey God pawa dey give and na dis God raiz am up.
COL 2:13 Even doh una bin don die inside una sin bikos dem nor sekonsaiz una body, God kon make una dey alive with am, bikos E don forgive una sins.
COL 2:14 E don distroy doz bad-bad tins wey una dey do and wetin dem rite about awa debt wey fit kill us, God remove am kon nail dem for di cross.
COL 2:15 God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.
COL 2:16 So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.
COL 2:17 Bikos all dis tins na shadow for di tins wey go kom, but di really tin, na Christ!
COL 2:18 Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.
COL 2:19 Dat pesin nor dey with Christ wey bi di head. Bikos na Christ join di whole body togeda, as dem dey grow inside God.
COL 2:20 Since una don die with Christ and e don free una from wiked pipol, den why una still dey bihave as pipol wey nor know God?
COL 2:21 Wen dem sey, make pipol nor whole, chop or tosh some tins, e nor mean anytin.
COL 2:22 All dis tins dey yuzles as pipol dey use dem, bikos na human being make all dis rules.
COL 2:23 E bi like sey dis tins get wisdom, bikos pipol dey woship angels; dey pritend sey dem good and dey sofa dia body, but dis wisdom nor get value, bikos e nor fit stop pesin make e nor do di yeye tins wey dey en mind.
COL 3:1 So, if God raiz una with Christ, den make una put mind for tins wey dey heaven; di place where Christ for sidan for God rite side.
COL 3:2 Make una dey tink about tins for heaven, nor bi tins for dis eart,
COL 3:3 bikos una don die and una life dey save with Christ for inside God.
COL 3:4 Wen Christ (wey bi una life) go kom, una go follow am kom with glory.
COL 3:5 So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.
COL 3:6 Na dis tins dey make God vex for doz wey nor dey obey am.
COL 3:7 Na so una dey live una life before wen una bi sinnas,
COL 3:8 but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life.
COL 3:9 Since una don kill una old sef and di tins wey una dey do before, make una nor dey lie give each oda.
COL 3:10 Make una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to know and bi like di Pesin wey kreate una.
COL 3:11 For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.
COL 3:12 So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.
COL 3:13 Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.
COL 3:14 With all dis good tins, make una love one anoda, bikos na love bi di best tin wey fit whole una togeda.
COL 3:15 Make Christ peace dey rule una heart (bikos na thru dis peace, Christ take koll una as one body) and make una dey tank God.
COL 3:16 Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
COL 3:17 For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.
COL 3:18 Una wey bi wife, make una dey do wetin una husband wont, as Christ pipol suppose do.
COL 3:19 Una wey bi husband, make una love una wife and nor dey wiked to dem.
COL 3:20 Una wey bi pikin, make una dey obey una papa and mama for evritin, (dey do evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Christ like bi dat.
COL 3:21 Una wey bi papa, make una nor do wetin go make una shidren vex, so dat life nor go taya dem.
COL 3:22 Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.
COL 3:23 Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol,
COL 3:24 bikos una know sey na Christ una really dey serve and una know sey E go reward una.
COL 3:25 Pesin wey do bad, God go pay am back for wetin e do, bikos God dey judge evribody akordin to wetin dem do, since E nor dey support anybody anyhow.
COL 4:1 Una wey bi masta, make una trit una savants well and nor shit dem, bikos una know sey, unasef get masta for heaven.
COL 4:2 Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray.
COL 4:3 Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.
COL 4:4 Make una pray make I tok well, so dat pipol go undastand mi.
COL 4:5 Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well.
COL 4:6 Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.
COL 4:7 Tikikus, my broda wey I love and awa Oga God savant; wey dey work well-well like mi, go tell una evritin wey dey happen to mi.
COL 4:8 Na bikos of dis I send am kom meet una, so dat una go know how tins bi for us and make e for give una heart.
COL 4:9 Onesimus, di broda wey dey with us, wey wi love well-well, wey bi one of una, I dey send am follow Tikikus. Dem go tell una evritin wey dey happen for here.
COL 4:10 Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too.
COL 4:11 Jesus wey dem still dey koll Justus, dey greet una. Jew pipol wey bi Christian and dey follow mi do God work, na only dem dey help mi.
COL 4:12 Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.
COL 4:13 Bikos I bi witness sey, e don work well-well for una and doz wey dey Laodicea and Hierapolis.
COL 4:14 Awa friend Demas and Luke, wey wi love well-well, wey bi doctor, dey greet una too.
COL 4:15 Make una tell di brodas and sistas wey dey Laodicea, with Nimfa and di pipol wey dey gada for en house sey, I greet dem.
COL 4:16 And afta una don read dis leta, make una let di pipol for di church wey dey Laodicea, read am too. Den make una still read di leta wey I rite give dem.
COL 4:17 Make una tell Arkippus sey, make e finish di work wey Christ gi-am.
COL 4:18 Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.
1TH 1:1 Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika. Make God grace and peace dey with una.
1TH 1:2 Wen ever wi dey pray, wi dey always tank God for all of una.
1TH 1:3 Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.
1TH 1:4 Awa brodas and sistas wey God love, wi know sey God don choose una as en own.
1TH 1:5 Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.
1TH 1:6 So, una kon bigin do as wi and Christ dey do; even doh una sofa well-well, una receive di message with joy wey di Holy Spirit dey give.
1TH 1:7 So una bi ezample to all di pipol wey bilive Jesus for both Masidonia and Akaia.
1TH 1:8 Bikos nor bi only sey di message about Christ don rish evriwhere for Masidonia and Akaia, but dem don hear di news about una faith for evriwhere. So wi nor even nid to tok about una again.
1TH 1:9 Pipol dey tok about how una welkom us and leave di juju wey una dey serve before kon follow di true God wey get life.
1TH 1:10 And una dey wait en pikin wey dey kom from heaven. Dis na en pikin, Jesus wey E wake from deat and na-im go save us from God vexnashon wey dey kom.
1TH 2:1 Awa brodas and sistas, una know sey awa visit nor dey yuzles.
1TH 2:2 Before wi kom meet una for Tesalonika, dem sofa and trit us anyhow for Filippi and many pipol nor wont make wi tok, but awa God give us pawa to prish en Good News.
1TH 2:3 Bikos wetin wi dey prish nor bi with mistake, dirty mind or wayo,
1TH 2:4 but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.
1TH 2:5 As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.
1TH 2:6 Wi nor ever sey make pipol praiz us; weda na una or odas.
1TH 2:7 Wen wi dey with una, wi dey gentol like as mama dey kare for en pikin, even doh wi for fit kollect money from una since wi bi Christ apostles.
1TH 2:8 Bikos wi love una, wi dey happy as wi dey share God word and awa own life with una.
1TH 2:9 But awa brodas and sistas, wi hope sey una remember as wi dey work for both day and nite, so dat as wi dey prish di gospel, wi nor go bi problem to una.
1TH 2:10 As wi dey live with una wey bilive Christ, una and God na awa witness sey, wi dey holy and dey do good tins for God eye without fault.
1TH 2:11 As unasef know, wi dey trit una as papa dey trit en shidren.
1TH 2:12 Wi dey advise, beg and tok to una sey, una must live una life as God wont, bikos na-im koll una enter en own kingdom and glory.
1TH 2:13 Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.
1TH 2:14 My brodas and sistas, na di same tin happen to God church for Judea and una wey bilive Christ for der don still sofa pain from una kountry-men wey bi Jew pipol.
1TH 2:15 Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.
1TH 2:16 Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.
1TH 2:17 My brodas and sistas, afta wi leave una (even doh wi still dey tink about una), wi kon dey try to make sure sey wi si una again bikos of di love wey wi get for una.
1TH 2:18 Wi bin won kom si una (mi wey bi Paul don try to kom many times), but Satan spoil awa plan.
1TH 2:19 Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!
1TH 2:20 Bikos na una bi awa joy and glory!
1TH 3:1 Wen wi nor fit bear-am again, wi kon sey wi go stay for Atens by awasef.
1TH 3:2 So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,
1TH 3:3 so dat nobody among una go dey fear, bikos of all dis sofa. Unasef know sey all wetin dey happen, na as God plan am.
1TH 3:4 Wen wi dey with una, wi dey tell una before di time rish sey, wi go sofa well-well and e don dey happen as una dey si am.
1TH 3:5 So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.
1TH 3:6 But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.
1TH 3:7 So, awa brodas and sistas, for all awa trobol and sofa, awa heart dey strong about una, bikos of una faith.
1TH 3:8 Naw, wi dey alive again, bikos una stand well for Christ
1TH 3:9 and wi dey tank God for una. Wi dey tank am for di joy wey wi get for en present bikos of una.
1TH 3:10 Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.
1TH 3:11 Make God awa papa and Oga God Jesus prepare road for us, so dat wi go si una again.
1TH 3:12 Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,
1TH 3:13 so dat una heart go dey strong for holiness. And for di time wey Christ go kom with en pipol, una go dey without fault for God present.
1TH 4:1 Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.
1TH 4:2 Una know di kommand wey wi give una thru Christ.
1TH 4:3 Na wetin God wont bi dis: Make una dey holy; komot hand for bad tins; nor sleep with who nor bi yor wife or husband.
1TH 4:4 Una wey bi man, make una dey live with una wife for holiness and with respet,
1TH 4:5 nor bi to dey follow who yu nor marry, just as Gentile pipol wey nor know God dey do.
1TH 4:6 Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.
1TH 4:7 Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.
1TH 4:8 So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.
1TH 4:9 No nid to rite give una about love for una fellow Christians, bikos God ensef don tish una about how una suppose love each oda.
1TH 4:10 And una really dey show love to di Christian brodas and sistas for Masidonia. My brodas and sistas, wi dey beg una sey, make una kontinue to dey do like dat.
1TH 4:11 Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.
1TH 4:12 Like dis, doz sinnas go dey respet una and una go get evritin wey una nid.
1TH 4:13 Awa brodas and sistas, wi wont make una know di trut about doz pipol wey don die, so dat una nor go dey sad like pipol wey nor get hope.
1TH 4:14 Since wi bilive sey Jesus die and e wake-up; na so too wi bilive sey, doz wey bi Christian before dem die, God go raiz dem up.
1TH 4:15 Bikos wetin wi dey tish una naw, na wetin Christ tish sey: Wi wey dey alive wen Jesus go kom, nor go follow am go kon leave doz wey don die bikos, all of us go-go with am.
1TH 4:16 God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.
1TH 4:17 God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven.
1TH 4:18 So make una dey enkourage each oda with all dis word.
1TH 5:1 Brodas and sistas, koncerning di time and sizin wen dis tins go happen, wi nor nid to rite anytin give una.
1TH 5:2 Bikos una really know sey, di day wen Christ go kom, e go bi like wen tif dey kom for nite.
1TH 5:3 Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
1TH 5:4 But una wey bi awa brodas and sistas, make una komot from darkness, so dat, dat day nor go kom meet una as tif dey kom wen nobody dey espect,
1TH 5:5 bikos all of una na lite shidren. Wi nor bi nite or darkness shidren,
1TH 5:6 so make wi nor dey sleep as odas dey do, but make wi shine awa eye well-well.
1TH 5:7 Na for nite pipol dey sleep and dey drink anyhow.
1TH 5:8 But since wi bilong to lite, make wi dey kwayet, use faith and love take protet awa chest, den wear di hope wey wi get like priest kap for head.
1TH 5:9 Bikos God nor choose us to sofa en vexnashon, but to get salvashon thru awa Oga God Jesus Christ
1TH 5:10 wey die for us, so dat weda wi dey alive or wi don die wen e kom, wi go stay togeda with am for heaven.
1TH 5:11 So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.
1TH 5:12 Naw wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una dey respet doz wey dey work, guide and tell una wetin to do about dis matter wey koncern Christ.
1TH 5:13 Bikos of di work wey dem dey do, make una love and respet dem well-well.
1TH 5:14 Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.
1TH 5:15 Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.
1TH 5:16 Make una dey happy evritime.
1TH 5:17 Make una dey pray evritime.
1TH 5:18 Make una dey tank God for evritin, bikos na so God wont sey make una wey dey inside Christ dey do.
1TH 5:19 Make una nor drive God Spirit komot for una life.
1TH 5:20 Make una nor take God word wey pesin tok as yeye tin.
1TH 5:21 Make una test evritin kon dey do wetin good.
1TH 5:22 Make una nor put hand for wiked and evil tins.
1TH 5:23 Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault.
1TH 5:24 Di Pesin wey koll una to do en work dey faithful.
1TH 5:25 My brodas and sistas, make una pray for us.
1TH 5:26 Make una greet all di brodas and sistas as God wont am.
1TH 5:27 I kommand una with Jesus name sey, make una read dis leta give all di brodas and sistas wey bilive.
1TH 5:28 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
2TH 1:1 Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika.
2TH 1:2 Make grace and peace wey God awa papa and Oga God Jesus Christ dey give, dey with una.
2TH 1:3 Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.
2TH 1:4 So, bikos of una faith and how una dey bear wahala and sofa, wi dey use una boast to all di pipol for God church.
2TH 1:5 Dis na sign sey God dey give korrect judgement. E wont make una dey good to inherit en kingdom and na bikos of dis kingdom, una dey sofa so.
2TH 1:6 E good as God dey ponish di pipol wey dey trobol una.
2TH 1:7 And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.
2TH 1:8 Den Christ go use fire wey nor dey kwensh take ponish doz wey nor know God and wey nor dey obey wetin wi dey prish about am.
2TH 1:9 God go distroy dem and dia ponishment nor go ever end. Wen Christ go kom receive glory from di pipol wey e choose,
2TH 1:10 e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una.
2TH 1:11 Na dis make us dey always pray for una sey, as God koll una, E go make una dey good and evry good tin wey una wont, go happen to una thru en pawa, so dat una work wey una dey do with faith, go komplete.
2TH 1:12 So, bikos of una, pipol go dey praiz awa Oga God Jesus Christ and akordin to awa God and Oga God Jesus Christ grace, unasef go dey receive en blessing.
2TH 2:1 Naw my brodas and sistas, for di time wen Jesus go kom and wen God go gada us go meet am, wi won tell una sey,
2TH 2:2 make fear nor dey una mind or spirit; even doh wi tell or rite give una sey Christ go soon kom.
2TH 2:3 Make nobody deceive una. Bikos dat day nor go kom until trobol go first kom and true-true, di pesin wey God go distroy, go kom out.
2TH 2:4 E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.
2TH 2:5 Una remember sey wen I dey with una before, I tell una all dis tins.
2TH 2:6 And una know wetin dey stop am, bikos e go only kom out wen en time don rish.
2TH 2:7 Dis wikedness don already dey work for sekret and dem go dey sekret until di pesin, wey bi di Holy Spirit wey dey whole dem, go komot for road.
2TH 2:8 Den evribody go know who dis wiked man bi and God go distroy am with breeze from Christ mout kon beri am with di glory wey dey kom.
2TH 2:9 Di wiked man go kom with Satan pawa and e go do difren mirakles and wonders.
2TH 2:10 E go use wayo deceive doz wey go perish, bikos dem nor won love and respet di trut wey for save dem.
2TH 2:11 So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie.
2TH 2:12 Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut.
2TH 2:13 But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.
2TH 2:14 E koll una enter en salvashon thru awa message, so dat una go fit get share for Christ glory.
2TH 2:15 So, my brodas and sistas, make una stand well for groun kon whole wetin wi tish una tait; weda na thru di words wey wi tok or letas wey wi rite.
2TH 2:16 Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope,
2TH 2:17 go enkourage and give una pawa for all di good work wey una dey do or di words wey una dey tok.
2TH 3:1 Finally, my brodas and sistas, make una pray for us, so dat Christ message go kontinue to spread kon get glory just as e really get among una.
2TH 3:2 Make God diliver us from wiked and evil pipol, bikos nor bi evribody get faith.
2TH 3:3 But Christ dey keep en promise and E go make una strong.
2TH 3:4 Wi get mind sey Christ go help una and una go do all di tins wey wi tell una.
2TH 3:5 I pray make God guide una heart to undastand en love more-more, so dat una go get Christ patient.
2TH 3:6 My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.
2TH 3:7 Una know sey una suppose to dey imitate us, bikos wi nor bihave anyhow wen wi dey with una.
2TH 3:8 Wi nor chop anybody food wey wi nor pay for. Instead, wi dey struggol and work hard for day and nite, so dat wi nor go bi wahala to una.
2TH 3:9 Nor bi sey wi nor get rite to ask una, but wi won use awasef as ezample for una,
2TH 3:10 bikos even wen wi dey with una, wi tell una sey, “Pesin wey nor ready to work, make e nor chop.”
2TH 3:11 Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin.
2TH 3:12 Wi dey kommand and enkourage dis kind pipol with awa Oga God Jesus Christ name sey, make dem do dia work well, so dat dem go fit feed demsef.
2TH 3:13 My brodas and sistas, make e nor taya una to do good.
2TH 3:14 But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.
2TH 3:15 Make una nor si am as enemy, but make una korrect am as una broda.
2TH 3:16 Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.
2TH 3:17 Na mi Paul dey rite and greet una with my own hand, just as I dey do for evry leta wey I don send kom meet una.
2TH 3:18 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with all of una.
1TI 1:1 Paul wey bi Jesus Christ apostle thru God awa Savior kommand, na-im rite dis leta and na Jesus Christ bi di hope wey wi get:
1TI 1:2 To Timoti, my own pikin for di faith. Make favor, mesi and peace wey dey kom from God awa papa and Jesus Christ awa Oga God, dey with yu.
1TI 1:3 As I tell yu wen I dey go Masidonia, make yu korrect doz pipol for Efesus wey nor dey tish di trut
1TI 1:4 but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.
1TI 1:5 But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
1TI 1:6 Some disobey dis kommand kon dey tok tins wey nor dey good.
1TI 1:7 Dem won tish pipol di law, but dem nor undastand wetin dem dey tok, even doh dem dey tok with strong heart.
1TI 1:8 But wi know sey di law dey good wen pipol dey obey am.
1TI 1:9 God nor give di law, bikos of good pipol, but na for pipol wey dey disobey and do anyhow. Dis kind pipol dey like to sin and dem nor dey fear God. Dem nor dey holy or get respet for anytin and dem fit kill dia papa, mama or anybody.
1TI 1:10 Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
1TI 1:11 wey dey dis betta gospel, wey awa Oga God sey make I dey prish.
1TI 1:12 I tank Christ awa Oga God, wey give mi pawa to do en work. Even doh I dey tok bad about am and dey opress en pipol before,
1TI 1:13 e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.
1TI 1:14 But God grace big well-well with faith and love wey dey for Jesus Christ.
1TI 1:15 Dis na true word and e good for evribody to asept and bilive am sey: “Jesus Christ kom dis world kon save sinnas” and na mi worse pass.
1TI 1:16 But God sorry for mi, so dat Christ go use mi as betta ezample to show sey, e dey patient with even di pesin wey sin pass. Den odas go know sey, demsef go fit bilive am kon get life wey nor dey end.
1TI 1:17 Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!
1TI 1:18 Timoti my pikin, na as dem tok for di words wey dem profesai about yu before, na-im make mi give yu dis kommand. So make dis words make yu strong as yu dey fight for Christ.
1TI 1:19 Whole yor faith for Christ well and make yor mind dey klear. Bikos some pipol nor dey use good mind and bikos of dat, dia faith don skata.
1TI 1:20 Hymenaeus and Alexanda na ezample of doz kind pipol. I don give dem to Satan, so dat dem go stop to dey tok anyhow about God.
1TI 2:1 First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody.
1TI 2:2 Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God.
1TI 2:3 Dis kind tin good and na wetin God awa Savior dey like,
1TI 2:4 bikos E wont make evribody dey save and undastand di trut.
1TI 2:5 Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda.
1TI 2:6 E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish.
1TI 2:7 Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).
1TI 2:8 So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel.
1TI 2:9 I wont make wimen dey dress well with sef kontrol. Nor make yeye hair style; nor wear too mush gold or stones and klot wey dear well-well.
1TI 2:10 Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi.
1TI 2:11 Make wimen dey kwayet and listin well as dem dey learn.
1TI 2:12 I nor allow woman tish or give dem authority ova men. Make dem kwayet dey listin,
1TI 2:13 bikos na Adam God first kreate, nor bi Eve.
1TI 2:14 And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world.
1TI 2:15 But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef.
1TI 3:1 Dis na true word: If any man like to bi leader, na betta work e wont.
1TI 3:2 Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.
1TI 3:3 Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money.
1TI 3:4 E must bi pesin wey dey manage en own house well and dey make en shidren obey and respet am.
1TI 3:5 If pesin nor fit manage en own house, na how e go take manage God church?
1TI 3:6 Who won bi leader must bi pesin wey get strong faith, bikos if e nor strong for faith, e go start to karry body up, den Satan go ponish am.
1TI 3:7 Pipol wey nor dey di church must dey tok good about di pesin wey bi leader, so dat dem nor go disgrace and make am fall enter devil trap.
1TI 3:8 Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money.
1TI 3:9 Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us.
1TI 3:10 Before dem go choose deakons, make dem test dem well-well. If dem pass di test, den dem fit serve as deakons.
1TI 3:11 Like dis too, dia wifes must get good karata, nor bi wifes wey dey lie or gossip, but dem must fit dey kontrol diasef and dey honest for evritin.
1TI 3:12 Deakons must dey faithful to en wife and must fit kontrol en shidren and evritin for en house.
1TI 3:13 Doz wey don serve well as deakons, pipol go respet dem well-well and di faith wey dem get for Christ, go dey strong.
1TI 3:14 I dey rite all dis kommand to una naw, even doh I dey hope to kom si una soon,
1TI 3:15 so dat if I nor kwik kom, una go know how pipol suppose bihave for God church, wey bi di true pila and foundashon.
1TI 3:16 Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.
1TI 4:1 Di Spirit tok sey for di last days, some pipol go leave di faith kon dey bilive lie-lie spirits and follow wetin demons dey tish.
1TI 4:2 Dis pipol dey lie and na wayo dem sabi do and dia mind don skata.
1TI 4:3 Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.
1TI 4:4 Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,
1TI 4:5 bikos God word and prayer don make am klean.
1TI 4:6 If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.
1TI 4:7 But make una rijet lie-lie and yeye story. Instead make una dey train unasef with betta words from God.
1TI 4:8 Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.
1TI 4:9 Dis na true word and e good make evribody asept am with betta mind.
1TI 4:10 Na dis make wi dey work hard and dey struggol, bikos awa hope dey with God wey dey alive and E dey save evribody, especially doz wey bilive am.
1TI 4:11 Make yu tish di pipol dis tins and make sure sey, dem do dem.
1TI 4:12 Nor let anybody opress yu bikos of yor age; but make yu show ezample to doz wey bilive thru yor word, karata, love, faith and as yu pure rish.
1TI 4:13 Until I kom back, make yu dey read God Word for church, dey enkourage di bilivers and tish dem.
1TI 4:14 Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.
1TI 4:15 Make yu dey learn dis tins; dey do am with all yor mind, so dat pipol go si as yu dey progress.
1TI 4:16 Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.
1TI 5:1 Make yu nor tok anyhow to pesin wey old pass yu, but dey tok to am with respet like sey yu dey tok to yor papa. Tok to yong men as yu go take tok to yor broda.
1TI 5:2 Make yu trit wimen wey old pass yu like sey dem bi yor mama and wimen wey yu senior, make yu trit dem with good mind like sey dem bi yor sistas.
1TI 5:3 Respet and kare for wimen wey dia husband don die.
1TI 5:4 But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God.
1TI 5:5 Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.
1TI 5:6 But if e just dey enjoy ensef anyhow for dis world, dat mean sey en spirit don die, even doh e still dey alive.
1TI 5:7 Make yu always dey give dis kommand so dat dem nor go get fault.
1TI 5:8 But if anybody nor fit kare for en pipol, especially en family membas, e don deny di faith bi dat and e worse pass sina.
1TI 5:9 Woman wey don pass sixty years and e dey faithful to en husband bi for di man die, make una put am join doz wey di church dey help.
1TI 5:10 Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.
1TI 5:11 But yong woman wey en husband just die, make una nor put am join doz wey di church dey help, bikos wen dem dey hongry to marry again, dem go fit leave Christ kon bigin sin.
1TI 5:12 So God go judge dem, bikos dem don break dia promise.
1TI 5:13 For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.
1TI 5:14 So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.
1TI 5:15 Bikos some pipol don already dey follow Satan.
1TI 5:16 If anybody wey bilive get rilashons wey en husband don die, make e help dem. Make e nor worry di church about dem, so dat dem go fit help di oda wimen wey dia husband don die.
1TI 5:17 Doz wey dey lead well, make dem pay dem well, especially doz wey dey work and tish well-well, so dat di gospel go stand.
1TI 5:18 Bikos God word sey, “Animal wey dey harvest korn, make una nor tie en mout.” Anybody wey dey work, suppose get en pay.
1TI 5:19 Make yu nor asept any words wey dem tok against any leader, unless two or three pipol bear witness sey na true.
1TI 5:20 Doz wey dey sin, make yu korrect dem for evribody front, so dat e go bi warnin to odas.
1TI 5:21 For God, Jesus Christ and di angels wey dey with us, I dey enkourage yu make yu obey all di kommand without wayo.
1TI 5:22 Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.
1TI 5:23 Nor dey drink only wota, but make yu still drink small wine bikos of yor belle wey dey make yu sick anyhow.
1TI 5:24 Remember sey some pipol dey sin make evribody si am and dis dey judge dem. But e get some wey yu nor go know dia sins naw, but leta, e go kom out for publik.
1TI 5:25 Like dis too, pipol dey si di good work wey odas dey do and one day, di good work wey dem do for sekret, go kom out for publik.
1TI 6:1 Una wey bi savants, make una dey respet una masta, so dat nobody go tok bad about God and wetin wi dey tish.
1TI 6:2 Make una nor disobey una masta, bikos dem bi bilivers. But make una serve and love dem well, bikos di mastas wey una dey serve, na Christian dem bi. Timoti, make yu tish dis tins and dey enkourage evribody to obey am.
1TI 6:3 If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life,
1TI 6:4 dat pesin dey proud and na only to dey argue and kworel, e know. Dis kind tin nor good, bikos jealousy; kworel; lie-lie; to dey suspet odas anyhow
1TI 6:5 and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.
1TI 6:6 To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward.
1TI 6:7 Bikos wi nor bring anytin kom dis world and true-true, wi nor go take one singol tin komot from dis world afta wi don die.
1TI 6:8 But if wi get food to chop and klot to wear, make dem rish us.
1TI 6:9 Pipol wey won get money by force, dey fall enter temptashon and dem dey get troat for yeye tins wey go distroy and put dem for wahala.
1TI 6:10 Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.
1TI 6:11 But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
1TI 6:12 Make yu fight di fight wey dey make faith strong and whole di life wey nor dey end, wey go make pipol praiz God, bikos na dis make am koll yu.
1TI 6:13 Before God wey dey give life to all tins and Jesus Christ wey tok well for Pontius Pilate front, I dey tell yu from my heart sey,
1TI 6:14 make yu obey dia kommand without fault or blame, until awa Oga God Jesus Christ go kom.
1TI 6:15 Bikos wen di time don rish, Christ go kom from heaven with God mighty pawa: Na God bi di King for all kings and Oga God of all oga.
1TI 6:16 Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!
1TI 6:17 Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.
1TI 6:18 Tell dem sey, make dem use dia money take do good. Make dem dey do plenty good works kon dey give doz wey nor get and make dem always dey ready to share with odas.
1TI 6:19 If dem dey do like dis, dem go dey use dia money and propaty take lay good foundashon for dia future, so dat dem go get life wey nor dey end.
1TI 6:20 Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.
1TI 6:21 Some pipol don fall komot from di faith, bikos dem dey listin to pipol wey dey do doz bad tins. Make God grace dey with all of una.
2TI 1:1 Na Paul, Jesus Christ apostle rite dis leta, bikos na so God wont am, so dat I go prish about di life wey God promise us thru Christ.
2TI 1:2 To Timoti, my pikin wey I love. Make grace, mesi and peace dey with yu from God awa Papa and awa Oga God Jesus Christ.
2TI 1:3 Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.
2TI 1:4 Wen I remember as yu take kry, e dey hongry mi to kom si yu, so dat joy go full my mind.
2TI 1:5 I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.
2TI 1:6 Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.
2TI 1:7 Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.
2TI 1:8 So make yu dey proud to tok about Christ or about mi wey dey prison bikos of am and make yu use di pawa wey God give yu, take follow mi sofa for dis gospel.
2TI 1:9 Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
2TI 1:10 But naw, E don bring all dis plan out wen awa Oga God Jesus Christ kom dis world. E distroy deat pawa kon bring life wey nor dey end thru di gospel.
2TI 1:11 Na dis gospel make God choose mi as prisha, apostle and tisha.
2TI 1:12 And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.
2TI 1:13 Make yu kontinue with di word wey I tell yu kon dey do am with di faith and love wey dey inside Christ.
2TI 1:14 Make yu guide di good tins wey God give yu thru di Holy Spirit wey dey inside us.
2TI 1:15 Yu know sey evribody for Asia, Figelus and Hermogenes aria, don run leave mi.
2TI 1:16 Make God show en mesi to Onesiforus family, bikos e dey always make mi happy and e nor dey shame sey I dey prison.
2TI 1:17 Wen e kom Rome, e find mi for evriwhere until e si mi.
2TI 1:18 For di day wen Christ go kom, make e show am en mesi! And yu know how e help mi wen I dey Efesus.
2TI 2:1 So yu, my pikin, make yu dey strong for di grace wey Christ dey give.
2TI 2:2 Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.
2TI 2:3 Make yu dey ready to sofa as mi and odas dey sofa, so dat yu go bi good soja for Christ.
2TI 2:4 Nor-tin koncern sojas with tins wey ordinary pipol dey do; if not, e nor go do wetin en oga wont.
2TI 2:5 Bikos anybody wey dey run race, nor go fit win unless e follow di rule wey dey di game.
2TI 2:6 Farmer wey work well-well, naim suppose get di first share for di harvest.
2TI 2:7 Make yu tink about wetin I dey tok so and Christ go help yu to undastand evritin.
2TI 2:8 Remember Jesus Christ wey kom from David family; di pesin wey God raiz from deat; bikos na so e bi for di message wey I dey prish
2TI 2:9 and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!
2TI 2:10 So I dey ready to bear di sofa, as long as e go save doz wey God don choose inside Christ with glory wey go dey forever and ever.
2TI 2:11 Dis word na true: If wi die with am, wi go live with am too.
2TI 2:12 If wi bear with am, den wi go reign with am too and if wi sey wi nor know am, en too go sey, e nor know us.
2TI 2:13 Weda wi get faith for am or not, Christ go still bi who e bi and e nor go shange.
2TI 2:14 Make yu remind evribody about dis tins, den make yu kommand dem for God present sey, make dem nor dey argue about words, bikos doz kind tins nor dey good and e fit konfuse doz wey dey listin.
2TI 2:15 Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.
2TI 2:16 Make yu nor put mout for yeye tok, bikos pipol wey dey do doz tins, dey far from God.
2TI 2:17 Dia word dey spread like diziz and na dis tin happen to Hymenaeus and Filetus.
2TI 2:18 Dem leave di trut kon dey sey resureshon don happen already and like dis, dem don make some pipol fall from di faith.
2TI 2:19 But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”
2TI 2:20 Wen yu go rish man house, nor bi only gold and silva tins dey der, but tins wey dem use wood and klay take make still dey der too and some dey make di house fine and odas nor good at-all.
2TI 2:21 So if yu keep yorsef without fault, yu go bi betta pesin wey Christ fit use as e dey do en good work.
2TI 2:22 Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.
2TI 2:23 I dey tell yu again sey, make yu nor put mout for yeye word, bikos yu know sey dis kind tin dey kause kworel.
2TI 2:24 Pesin wey bi Christ savant nor dey kworel, instead e must dey good with evribody; must sabi tish well-well and get patient with sturbon pipol.
2TI 2:25 E must dey gentol as e dey korrect pipol wey dey oppoz en prishin and God fit let dis pipol turn from sin kom meet am, so dat dem go know di trut.
2TI 2:26 Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.
2TI 3:1 Make yu undastand sey, for di last days before dis world go end, tins go hard well-well.
2TI 3:2 Pipol go dey tink of diasef alone; dey like money; dey boast; dey karry body up; dey tok bad about God; dey disobey dia papa and mama and dem nor dey tank even pipol wey do good for dem.
2TI 3:3 Dem nor get love or forgivenes; dem go dey gossip odas and nor fit kontrol diasef. Dem go dey wiked and hate wetin good.
2TI 3:4 Dem go betray dia friends; dey do tins before dem tink; dey feel sey dem dey important and dem go love enjoyment pass God.
2TI 3:5 If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.
2TI 3:6 Bikos na dis pipol dey hide enter pipol house kon sleep with wimen wey nor get sense; wey dey sin well-well and wetin dey sweet dis wimen to do, na-im dey kontrol dem.
2TI 3:7 Doz kind wimen dey try to learn, but dem nor dey fit know di trut.
2TI 3:8 Just as Jannes and Jambres oppoz Moses; na so too, dis pipol wey dia mind block and nor get faith, dey oppoz di trut.
2TI 3:9 But dem nor go do am tey, bikos evribody go si how dem foolish rish, just as e happen to Jannes and Jambres.
2TI 3:10 But yu don know my tishings; di way I dey live my life and why I dey do wetin I dey do: my faith; patient; love and as I dey bear.
2TI 3:11 Yu know di wahala and sofa wey happen to mi for Antiok, Ikonium and for Lystra. I bear all dis wahala and Christ save mi from dem.
2TI 3:12 True-true, anybody wey won live di kind life wey God wont inside Christ, make e know sey e must sofa.
2TI 3:13 But wiked and evil pipol nor go prosper. Dem go deceive odas and dem go deceive diasef too.
2TI 3:14 But make yu kontinue to do wetin yu learn. Yu know sey dis tins na true and yu trust doz wey tish yu.
2TI 3:15 Dem don tish yu God word since yu bi small pikin and yu don get salvashon to receive di wisdom wey dey kom thru Christ, wey yu trust.
2TI 3:16 Evry word wey dey Bible, kom from God and dem dey good to tish us di trut and to know di tins wey dey wrong for awa life. God word dey korrect us wen wi dey wrong and e dey tish us to do good tins,
2TI 3:17 so dat as wi dey do God work, wi go fit do am well and wi go get evritin wey wi nid to take do good tins.
2TI 4:1 I dey tell yu wetin to do for God and Jesus Christ present. Wen Christ go appear to make en kingdom stand, e go judge pipol wey dey alive and doz wey don die.
2TI 4:2 Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.
2TI 4:3 Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.
2TI 4:4 Dem go rijet di trut and love lie-lie story.
2TI 4:5 But make yu kontrol yorsef for evritin. Nor fear to sofa for Christ. Dey do God work and dey tell odas about di Good News.
2TI 4:6 For mi, I don already use my life as ofrin for God work, bikos di time wey I go die, don near.
2TI 4:7 I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.
2TI 4:8 Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.
2TI 4:9 Make yu try yor best to kom si mi soon.
2TI 4:10 Bikos Demas love dis world tins, e kon run leave mi go Tesalonika. Crescens don go Galatia and Titus go Dalmatia.
2TI 4:11 Na only Luke dey with mi. Make yu karry Mark follow body wen yu dey kom, bikos e go fit help mi for di ministry work.
2TI 4:12 I send Tikikus go Efesus.
2TI 4:13 Wen yu dey kom, bring di klot wey I leave with Karpus for Troas. Make yu bring my book, especially my papers.
2TI 4:14 Alexanda wey dey do iron work, wiked mi well-well, but Christ go judge am for wetin e do.
2TI 4:15 Make yu dey kareful with am, bikos e fight against evritin wey wi tok.
2TI 4:16 Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!
2TI 4:17 But God dey for my side and E give mi pawa, so dat thru mi, Gentile pipol go hear di Good News and Christ don save mi from lion mout!
2TI 4:18 And Christ go still save mi from evry evil plan until e take mi enter en kingdom. Make glory bi en own forever and ever. Amen!
2TI 4:19 Make yu help mi greet Priscilla, Akwila and Onesiforus family.
2TI 4:20 Erastus dey for Korint and bikos Trofimus nor well, I kon leave am for Miletus.
2TI 4:21 Make yu try kom before kold sizin go rish. Eubulus, Pudens, Linus, Klaudia and all di brodas and sistas dey greet yu.
2TI 4:22 Make Christ dey with yor spirit. Make God grace and favor dey with yu.
TIT 1:1 Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont.
TIT 1:2 Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.
TIT 1:3 As di time don rish, E don give us en message thru di word wey wi dey prish give evribody and na God awa Savior give mi pawa to do dis work.
TIT 1:4 I dey rite to Titus, my own pikin for faith. Make grace and peace wey dey kom from God awa Papa and from awa Savior Jesus Christ, dey with yu.
TIT 1:5 Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu.
TIT 1:6 Anybody wey won bi elder must dey good. E must get only one wife and en shidren must bi bilivers; dey gentol and dey respet demsef.
TIT 1:7 Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.
TIT 1:8 Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef.
TIT 1:9 E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.
TIT 1:10 Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz.
TIT 1:11 So wi must stop dem, bikos dem dey tish pipol tins wey go make pipol komot from di trut and dem dey do like dis, bikos of di money wey dem go get.
TIT 1:12 Even one among dia own profets sey, “Krete pipol dey always tok lie, dem bi wiked animals and lazy pipol wey get long-trot.”
TIT 1:13 Wetin di profet tok, na true. So bikos of dis, make yu stop dem, so dat di bilivers go strong for faith.
TIT 1:14 Make dem stop to listin to Jew pipol lie-lie story and nor dey bihave like doz wey nor bilive.
TIT 1:15 Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.
TIT 1:16 Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.
TIT 2:1 But for yu Titus, yu must tish pipol how to bihave well.
TIT 2:2 Make yu tish old men sey, make dem nor dey bihave anyhow, so dat pipol go respet dem and make dem dey kontrol demsef; get faith; dey show love and dey patient.
TIT 2:3 Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good.
TIT 2:4 So, make di old wimen train and tish di yong ones how dem go take love dia husband and shidren;
TIT 2:5 to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so.
TIT 2:6 Make yu tish yong men to dey live dia life with betta sense
TIT 2:7 and make yu yorsef bi good ezample to dem. Make evritin wey yu dey do, show sey wetin yu dey tish, na trut.
TIT 2:8 Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us.
TIT 2:9 Una wey bi savant, make una dey do evritin wey una oga wont and wen una oga tok to una, make una nor dey ansa am anyhow.
TIT 2:10 Make una nor dey tif, instead make una dey show sey una get faith, so dat evritin wey una dey do, go bring praiz to God awa Savior.
TIT 2:11 Bikos God grace wey bring salvashon, don kom out make evribody si am.
TIT 2:12 Di grace dey tish us sey, make wi nor live like pipol wey nor know God or dey bihave anyhow. So make wi dey kontrol awasef; dey do good and follow God for dis time wey wi dey so,
TIT 2:13 bikos wi dey wait for di day wen God sey Christ, wey bi awa God Almighty and Savior, go kom.
TIT 2:14 E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.
TIT 2:15 Make yu tish dem dis tins and korrect dem with boldness. So, make yu nor let anybody trit yu like small pikin.
TIT 3:1 Make yu remind di bilivers sey, make dem respet doz wey dey rule dem. Dem must obey and dey ready to do good.
TIT 3:2 Make dem nor ever tok bad about anybody, instead make dem dey live for peace, dey gentol and dey bihave well to evribody.
TIT 3:3 Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.
TIT 3:4 But wen God awa Savior show us di kindness and love wey E get for us,
TIT 3:5 E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
TIT 3:6 God give us dis Spirit for free thru Jesus Christ wey bi awa Savior.
TIT 3:7 Since Christ grace don make us klean for God eye, wi don bi pipol wey dey wait for di life wey nor go end and wi dey sure sey, wi go get am.
TIT 3:8 Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.
TIT 3:9 Nor put mout for word wey nor dey good: like matter wey koncern who born who and kworel or fight about Jew pipol law. All dis tin dey yuzles and dem nor mean anytin.
TIT 3:10 If anybody dey won kause kworel for di church and yu don warn am rish two times and e nor gri shange, den make yu drive am.
TIT 3:11 Bikos dat kind pesin don turn from di trut and en own sin go kondemn am.
TIT 3:12 If I send Artemas or Tikikus kom meet yu, make yu try kom meet mi for Nikopolis, bikos I don decide sey, na der I go stay until kold sizin go end.
TIT 3:13 Make yu do evritin wey yu fit do to help Zenas, wey bi lawyer and Apollos for dia journey and make sure sey dem get evritin wey dem nid.
TIT 3:14 Like dis too, awa pipol go learn how to do good and help pipol wey really nid help. And as dem dey do like dis, dem nor go live yuzles life.
TIT 3:15 Evribody wey dey with mi dey greet yu! Make yu greet all di pipol wey love us. Make God grace dey with all of una.
PHM 1:1 Na Paul wey bi prisona bikos of Jesus Christ and awa broda Timoti rite dis leta to Filemon, awa dear broda and ko-worker.
PHM 1:2 And to Afia awa sista, Arkippus awa fellow soja and di church pipol wey dey meet for en house.
PHM 1:3 Make God and awa Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
PHM 1:4 Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,
PHM 1:5 bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,
PHM 1:6 so I dey pray sey di faith wey yu get go make yu undastand all di blessings wey bi yor own inside Christ.
PHM 1:7 I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.
PHM 1:8 Since I get strong bilive for Christ sey, I fit tell yu make yu do wetin dey rite,
PHM 1:9 mi Paul, wey bi old man and prisona bikos of Christ, won advise yu with love.
PHM 1:10 Abeg, make yu dey kind to Onesimus, wey bi my pikin for God work and e dey prison with mi.
PHM 1:11 Before, e nor dey yuzful to yu, but naw, e dey yuzful to mi and yu.
PHM 1:12 I dey send am kom back kom meet yu (even doh I love am well-well).
PHM 1:13 If to sey yu dey here, I for wont make e help mi as I still dey prison bikos of di gospel work.
PHM 1:14 But I nor won do anytin wey yu nor go like, so dat di good wey yu do, nor go bi by force, but e go kom from yor mind.
PHM 1:15 May bi na bikos of dis make am nor dey with yu since, but naw, e go dey with yu forever.
PHM 1:16 Nor bi as slave, but as broda wey wi love, bikos e don big pass slave. E don bikom awa broda naw, bikos God don shange am.
PHM 1:17 So, if yu si mi as yor broda and patina, make yu asept am as yu go take asept mi.
PHM 1:18 If e tif or whole yu anytin before, make yu tell mi and I go pay.
PHM 1:19 Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.
PHM 1:20 So my broda, make yu do dis tin for mi bikos of Christ, so dat belle go sweet mi.
PHM 1:21 I dey sure sey yu go do wetin I ask yu, so I dey rite give yu, bikos I know sey yu go do pass wetin I ask.
PHM 1:22 So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.
PHM 1:23 Epafras, wey dey prison with mi, bikos of Jesus Christ, dey greet yu.
PHM 1:24 Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.
PHM 1:25 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with yor spirit.
HEB 1:1 Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,
HEB 1:2 but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world.
HEB 1:3 Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
HEB 1:4 E big pass di angels, just as di name wey God gi-am big pass angels own too.
HEB 1:5 Na wish angel God tell sey, “Yu bi my pikin, today I don bikom yor Papa?” Or as E tok for anoda place sey, “I go bi yor Papa and yu go bi my pikin?”
HEB 1:6 But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.”
HEB 1:7 God tok about di angels sey, “I make my angels and my savants spirit to dey burn like fire,”
HEB 1:8 but koncerning en pikin, E sey: “Yu bi God! Yor kingdom go dey forever and ever and yu go rule yor pipol with authority.
HEB 1:9 Yu love to do good and yu hate wikedness. So God, wey bi yor God don anoint yu with oil wey dey bring joy and E make yu dey above yor mates.”
HEB 1:10 E still tell di pikin sey: “For di biginnin, na God kreate di eart and na with en hand E take make di heavens.
HEB 1:11 Dem go skata, but God go dey forever. All of dem go grow kon old like klot
HEB 1:12 and like klot and koat, God go fold and shange dem, but God nor dey shange and en life nor go ever end.”
HEB 1:13 Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”
HEB 1:14 All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.
HEB 2:1 Make wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fall komot from di rite road.
HEB 2:2 Bikos di message wey God tok thru en angels, na trut and anybody wey disobey di law, God go ponish am.
HEB 2:3 Wetin make us sey wi go dey free if wi nor listin to dis korrect salvashon message? Na God first tok am and pipol wey hear am kon show us sey na trut.
HEB 2:4 God use signs, mirakles and wetin di Holy Spirit do, take show sey, dia words na true.
HEB 2:5 God nor sey make en angels kontrol di world wey dey kom and wey wi dey tok about so.
HEB 2:6 Instead, David tok for God word sey: “Wetin human being bi wey make yu dey kare for am and who bi yor pikin wey yu dey kare for like dis?
HEB 2:7 Aldo yu make angels high pass am small. But yu kon gi-am honor and glory.
HEB 2:8 Yu don put evritin under am sey make e kontrol dem. Wen God sey na evritin E put under am, E mean sey na evritin and nor-tin remain.” And naw, wi neva si all dis tins dey happen,
HEB 2:9 even doh wi si Jesus wey angels big pass small, e nor too tey before God gi-am glory and honor, bikos e sofa and die for evribody, just as God plan am.
HEB 2:10 Dis na true, bikos na from am and thru am evritin take kom dis life, so dat salvashon go dey korrect thru en sofa and e go karry many pipol enter en glory.
HEB 2:11 True-true, Jesus make pipol dey holy, so en and di pipol wey e make holy, na God kreate dem. Na dis make am nor dey shame to koll dem en brodas and sistas.
HEB 2:12 Jesus tell God sey, “I go announce yor name among pipol wey bilive and I go praiz yu for dia present.
HEB 2:13 Christ still sey, I go trust my God; both mi and di shidren wey E give mi.”
HEB 2:14 So as di shidren get flesh and blood, en too get flesh and blood like dem, so dat thru deat, e go fit distroy Satan wey get pawa to kill
HEB 2:15 and e go free pipol wey deat don whole.
HEB 2:16 Jesus dey koncern about Abraham shidren and nor bi only di angels.
HEB 2:17 So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.
HEB 2:18 Bikos Jesus sofa and devil tempt am, e don get pawa to save pipol wey devil dey tempt.
HEB 3:1 My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.
HEB 3:2 E obey God wey choose am as High Priest, just as Moses obey God.
HEB 3:3 Just as dem dey praiz pesin wey build fine house, pass di house wey e build, na so too Jesus glory betta pass Moses own well-well!
HEB 3:4 Na pesin build evry house, but di pesin wey build evritin, na God.
HEB 3:5 True-true, Moses really obey God as savant and e tok about some tins wey God go tok about leta.
HEB 3:6 But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.
HEB 3:7 As di Holy Spirit tok: “If una hear God vois today, make una listin to am!
HEB 3:8 Make una nor get strong heart for am, bikos na so Israel pipol do wen God test dem for wildaness.
HEB 3:9 Na for di wildaness una papa for test and try mi for forty years, even doh dem si di mirakles wey I do.
HEB 3:10 I vex well-well for dat generashon, so I kon tell dem, ‘Una heart nor dey with mi and una nor gri obey wetin I tok.
HEB 3:11 So, una nor go ever get rest.’ ”
HEB 3:12 Make una make sure sey non of una get bad mind wey go make una nor bilive, so dat una nor go turn against God wey nor dey die.
HEB 3:13 But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin.
HEB 3:14 Bikos wi go bi Jesus Christ friend, if wi whole awa faith strong go rish di end.
HEB 3:15 But as dem rite am, “I wish sey una go do wetin e tok, so dat una nor go get strong heart like Israel pipol wen dem dey wildaness.”
HEB 3:16 Na who bi di pipol wey nor listin to God, even doh dem hear en vois? Nor bi pipol wey Moses lead kom out from Egypt?
HEB 3:17 Na who make God vex well-well for forty years? Nor bi doz sinnas wey dia dead body skata for wildaness?
HEB 3:18 Na who God swear for sey, dem nor go ever get rest, nor bi doz wey disobey am?
HEB 3:19 So for dat time, doz pipol nor enter di land wey God promise dem, bikos dem nor bilive am.
HEB 4:1 Even doh God promise us rest, e good make wi dey kareful, so dat some among us nor go miss di promise.
HEB 4:2 Bikos dem prish God word give us, just as dem prish am give dem too. But dem nor take am sirious, bikos wen dem hear am, dem nor gri bilive am.
HEB 4:3 Na only wi wey bilive go fit enter di place where God rest dey, bikos God sey, “I vex kon swear for dem, so ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey!’ ”
HEB 4:4 Wi know sey God ready and dey wait, bikos Bible sey, “Afta God don kreate evritin finish, E kon rest for di sevent day.”
HEB 4:5 E still sey, “Dem nor go ever enter my place where rest dey!”
HEB 4:6 God promise sey wi go enter di place where en rest dey, yet doz wey first hear di message, nor enter, bikos dem disobey am.
HEB 4:7 But God don plan anoda time wen wi go enter en rest and dat time, “Na today”, bikos E don tok am for en word before thru David.
HEB 4:8 Bikos if to sey Joshua give dem rest, God for nor tok about anoda day.
HEB 4:9 So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol.
HEB 4:10 Bikos pesin wey enter God rest, don rest from all en work, just as God rest from en own work too.
HEB 4:11 So make wi try well-well, so dat wi go enter dat place where rest dey and non of us go fall like di odas wey nor obey.
HEB 4:12 God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.
HEB 4:13 Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.
HEB 4:14 Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.
HEB 4:15 Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.
HEB 4:16 Make wi nor fear to enter where God throne dey: di place where grace dey, so dat wi go get mesi and God grace go help us wen wi nid help.
HEB 5:1 Na God dey choose High Priest wey go ripresent pipol for en present. Di priest dey offa both gift and sakrifice for dia sins.
HEB 5:2 Di High Priest fit sorry for doz wey sin, bikos dem nor know wetin dem suppose know, since en ensef dey sin too.
HEB 5:3 Bikos of dis, e dey offa sakrifice for en sin and di pipol own.
HEB 5:4 Nobody dey fit bi High Priest with en pawa bikos e wont make pipol honor am, but na only doz wey God koll to bi priest, just as E koll Aaron.
HEB 5:5 Christ nor praiz ensef wen e bikom High Priest, but na God praiz am wen E sey, “Yu bi my Pikin! Today, I don bikom yor Papa.”
HEB 5:6 God still sey, “Yu bi priest forever as Melkizedek bi.”
HEB 5:7 Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.
HEB 5:8 Even doh e bi God Pikin, na thru all di tins wey e sofa, e take learn how to obey.
HEB 5:9 Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.
HEB 5:10 God make Christ to bi High Priest like Melkizedek.
HEB 5:11 Wi get many tins to tok about, but dem nor eazy to esplain, bikos una nor dey gri obey.
HEB 5:12 E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.
HEB 5:13 Anybody wey still dey drink milk, bi like small pikin wey nor know good from bad.
HEB 5:14 But solid food na for mature pipol and dem get betta sense to know wetin dey good and bad.
HEB 6:1 E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God;
HEB 6:2 wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement.
HEB 6:3 As God dey help us, na new-new tins wi go dey tish una about di faith.
HEB 6:4 Wen pesin don first know di trut; taste God gift from heaven; know di Holy Spirit;
HEB 6:5 don taste God good work and di betta wey dey kom,
HEB 6:6 den e kon start to sin, dat pesin nor go fit turn from sin kom meet God, since e don kill God Pikin for di sekond time and disgrace am for publik.
HEB 6:7 Wen rain don soak groun and e bear betta fruits for di farmer, dat mean sey God don bless di man.
HEB 6:8 But if na so-so shuku-shuku and grass di groun dey bear, dat mean sey e dey yuzles. So God go curse and distroy am with fire.
HEB 6:9 But as for una wey bi my friends, even doh wi dey tok to una like dis, wi know sey dis tins nor go happen to una, bikos una don undastand God salvashon.
HEB 6:10 God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
HEB 6:11 As una still dey dis world, wi wont make una kontinue to love one anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom.
HEB 6:12 So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.
HEB 6:13 Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey,
HEB 6:14 “Na mi bi Oga God, I go bless yu well-well and yor shidren go plenty.”
HEB 6:15 Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promise am.
HEB 6:16 Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter.
HEB 6:17 So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.
HEB 6:18 God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
HEB 6:19 Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;
HEB 6:20 di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.
HEB 7:1 Melkizedek wey bi “Salem king” and “God priest”, na-im bless Abraham, afta Abraham don win di kings for war.
HEB 7:2 So Abraham kon gi-am one from evry ten tin wey e bring kom back from war. Melkizedek mean, “King wey dey do wetin dey rite” and Salem mean, “Peace.”
HEB 7:3 E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever.
HEB 7:4 But si how e big rish, bikos Abraham (awa grand-grand papa wey evribody know) gi-am one out of evry ten tins wey e bring from war.
HEB 7:5 Levi shidren wey bi priests, get pawa akordin to di law, to kollect one out of evry ten tins from dia own pipol, even doh di pipol demsef, na Abraham shidren too.
HEB 7:6 But Melkizedek wey nor even rilate to Levi pipol, still kollect one out of evry ten tins from Abraham, den e kon bless Abraham wey God don promise.
HEB 7:7 True-true, wi know sey pesin wey bless pesin, na-im big pass di pesin wey e bless.
HEB 7:8 Evry priests dey kollect one out of evry ten tins wey pipol bring, but dem nor dey stay for di world forever, esept Melkizedek, bikos God word tish us sey, e dey alive.
HEB 7:9 Levi shidren dey kollect one out of evry ten tins from pipol, but naw, wi go fit sey, wen Abraham give one out of evry ten to Melkizedek, Levi pay too,
HEB 7:10 bikos dat time wen Abraham give one out of evry ten tins wey e bring from war to Melkizedek, dem neva born Levi, but Levi dey inside am.
HEB 7:11 Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family.
HEB 7:12 Since dem don shange di rule to selet priest, di law must shange too.
HEB 7:13 Di pesin wey wi dey tok about, na awa Oga God wey kom from di tribe where nobody don ever serve as priest for altar before.
HEB 7:14 Evribody know sey na from Judah tribe, Jesus from kom and Moses Law nor sey make priest kom from dat tribe.
HEB 7:15 Dis matter klear well-well afta God selet anoda priest like Melkizedek.
HEB 7:16 E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end.
HEB 7:17 God word sey: “Yu bi priest forever, just as Melkizedek bi.”
HEB 7:18 Bikos of dis, God put di old law for korna, since e dey weak and yuzles,
HEB 7:19 bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God.
HEB 7:20 God ensef make promise wen E choose dis priest, wey bi Jesus. E nor make dis kind promise wen E choose di oda priests,
HEB 7:21 but Jesus kon bi priest wen God sey, “I don swear and I nor go shange my mind sey yu go bi priest forever.”
HEB 7:22 Bikos God swear like dis, Jesus don make us dey sure of di new kovenant wey betta pass.
HEB 7:23 Many priests don dey before and all of dem die,
HEB 7:24 but Jesus nor go ever die. So, e go bi priest forever.
HEB 7:25 So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.
HEB 7:26 Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven
HEB 7:27 and e betta pass any oda high priests. Jesus nor nid to offa sakrifice evriday, like di oda priests wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifice ensef for evribody, wen e die for di cross.
HEB 7:28 Moses Law choose human being wey get weakness as High Priest, but God promise wey kom afta di law, choose di pikin and na-im bi di korrect Priest forever.
HEB 8:1 Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven.
HEB 8:2 Na-im bi di priest wey dey di holy Temple wey God build and na der dem for dey woship am.
HEB 8:3 Since all High Priest must offa gifts and sakrifice to God, Christ too must offa sometin.
HEB 8:4 If to sey e dey dis world, e nor for bi priest at-all, since na thru Moses Law dem take dey choose priest wey go offa sakrifice.
HEB 8:5 Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”
HEB 8:6 But Christ ministry big and betta pass dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) betta pass. Bikos na thru God promise dis kovenant take kom, so Christ don bi di middo-man between wi and God.
HEB 8:7 If to sey di first kovenant good well-well, den wi nor for nid anoda one.
HEB 8:8 But God si fault for inside, so E kon sey, “Di day wey I go make new agriment with Israel and Judah house, dey kom.
HEB 8:9 E nor go bi like di kovenant wey I make with dia grand-grand papa dem wen I take dem komot from Egypt, bikos dem break dat kovenant and I kon turn against dem.”
HEB 8:10 But naw, “Dis na my new kovenant (wey bi di new agriment): Di time dey kom wen I go put my laws for dia mout and rite am for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
HEB 8:11 Dem nor nid to tish one anoda about mi wey bi dia God, bikos all of dem, both small and big, go know mi.
HEB 8:12 I go forgive dem for all di wiked tins wey dem don do and I nor go remember dia sins again.”
HEB 8:13 Wen God tok about di new kovenant, E mean sey di first one nor matter again. And anytin wey don old and nor get use again, go soon disappear.
HEB 9:1 Di first kovenant show how pipol go woship God for dis world.
HEB 9:2 Di building get two rooms. Di first one where lantan-stand dey, “Na di Holy Place.” One tabol and di bread wey dem offa give God, dey der too.
HEB 9:3 Anoda room wey dem rite, “Holy of Holies”, dey for di curtain back.
HEB 9:4 Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.
HEB 9:5 God angels wey kover di place where God dey show mesi and forgive sins, dey on-top dis box. But dis nor bi di time for mi to esplain all dis tins give una.
HEB 9:6 Wen all dis tins don ready, di priests dey enter di first room evriday go do dia work.
HEB 9:7 But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.
HEB 9:8 Di Holy Spirit kon esplain sey, “Di way to rish di Holy Place neva open as long as di old tent still dey.”
HEB 9:9 Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean.
HEB 9:10 To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.
HEB 9:11 So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world.
HEB 9:12 Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.
HEB 9:13 If goat or ram blood and ashes fit klean pesin akordin to di old tradishon,
HEB 9:14 wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
HEB 9:15 Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.
HEB 9:16 Dis kind agriment bi like pesin will. Di pesin must die first, before dem go fit use di will.
HEB 9:17 Bikos pesin will nor dey mean anytin wen e still dey alive; e only dey yuzful wen di pesin don die.
HEB 9:18 Na dis make di first kovenant nor get pawa to save pipol, unless dem sakrifice blood.
HEB 9:19 Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey,
HEB 9:20 “Na dis bi di blood for di kovenant wey God kommand sey una must obey.”
HEB 9:21 Moses still sprinkol di blood for di tent and all di plate wey dem dey use take woship God.
HEB 9:22 True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins.
HEB 9:23 Na dis make dem dey klean di Holy Place for dis eart with animal blood, bikos e bi like di one for heaven. But di tins wey dey for heaven, nid sakrifice wey betta pass dat one.
HEB 9:24 Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.
HEB 9:25 Christ nor nid to offa ensef evry year like di High Priests dey do for di temple with animal blood,
HEB 9:26 bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever.
HEB 9:27 Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,
HEB 9:28 na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.
HEB 10:1 Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.
HEB 10:2 If pipol wey dey woship God don free from dia sins, dem nor for dey offa sakrifice again.
HEB 10:3 Doz sakrifice dey remind pipol of dia sins evry year,
HEB 10:4 since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins.
HEB 10:5 So wen Christ one kom dis world, e tell God: “Nor bi sakrifice and ofrin yu wont, bikos yu don prepare my body as ofrin,
HEB 10:6 since yu nor like animal blood as ofrin for sins again.
HEB 10:7 Den I sey, ‘Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do, just as yor word tok about mi for Moses Law.’ ”
HEB 10:8 Christ first sey, “Yu nor wont animal or sin ofrin, (even wen dem dey offa am akordin to di law).”
HEB 10:9 Den e tok again sey, “Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do.” So God remove di first sakrifice, so dat E go fit bring di new one, wey bi Christ.
HEB 10:10 Bikos Jesus do wetin God wont, all of us don dey holy thru di sakrifice wey e use en body make for us.
HEB 10:11 Before-before, di priest dey serve evriday and dey offa di same sakrifice wey nor fit remove sin.
HEB 10:12 But naw, Christ offa only one sakrifice for sin wons and for all, den e kon go sidan for God rite hand,
HEB 10:13 where e dey wait until God go put en enemies under en leg.
HEB 10:14 Na with one sakrifice e take klean pipol from dia sins and dem don dey klean forever.
HEB 10:15 Di Holy Spirit dey bear witness about dis tins sey,
HEB 10:16 “Dis na di kovenant wey I go make with una and afta dat time,
HEB 10:17 e kon sey, ‘I nor go remember dia sins and sturbones again.’ ”
HEB 10:18 Wen God don forgive sins, e get any nid to offa sakrifice again?
HEB 10:19 So my brodas and sistas, wi bilive sey wi go enter God Holy Temple thru Jesus Christ blood,
HEB 10:20 bikos e give us dis new life and e go take us pass di curtain wey bi en body.
HEB 10:21 And wi get one High Priest wey dey kare for God Temple.
HEB 10:22 So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.
HEB 10:23 So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise.
HEB 10:24 Make wi always dey tink of how wi go enkourage, love and do good for one anoda.
HEB 10:25 Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.
HEB 10:26 If wi kontinue to sin afta God don show us di trut, e nor get any oda sakrifice wey go fit forgive us awa sins again.
HEB 10:27 But wetin wi go dey fear for na di Judgement Day wey dey kom and hell-fire wey go distroy doz wey bi God enemies.
HEB 10:28 Wen two or three pipol bi witness sey somebody rijet Moses Law, dem go kill-am without sey dem sorry for am.
HEB 10:29 If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?
HEB 10:30 Bikos God sey, “I go revensh, I go pay dem back” and en word still sey, “God go judge en pipol.”
HEB 10:31 Na big wahala if pesin fall enter God ponishment!
HEB 10:32 But make una remember how tins bi with una before, how una dey sofa afta una don receive God lite, yet una nor allow di sofa shange una mind.
HEB 10:33 Dat time, some pipol curse and sofa una and for oda times, una dey help odas wey dey sofa like una too.
HEB 10:34 True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.
HEB 10:35 So make una always dey strong, bikos una go get betta reward.
HEB 10:36 Una nid to dey patient, so dat una go fit do wetin God wont and den, una go receive en promise.
HEB 10:37 Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom.
HEB 10:38 My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”
HEB 10:39 Wi nor dey among pipol wey go turn back kon perish, but wi get faith wey go save us forever.
HEB 11:1 Faith na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go happen and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom.
HEB 11:2 Na faith awa grand-grand papa dem take do tins wey make God praiz dem.
HEB 11:3 Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si.
HEB 11:4 Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.
HEB 11:5 Na faith nor let Enoch die, but God karry am take and nobody si am. God word sey, before God karry am, Enoch don make belle sweet God.
HEB 11:6 Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.
HEB 11:7 Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.
HEB 11:8 Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go.
HEB 11:9 Na faith make am stay as strenja for di land wey God promise am. Na inside tent en, Isaak and Jakob wey go inherit di same promise, stay.
HEB 11:10 Abraham do like dis, bikos e dey wait for di town wey God ensef go build with strong foundashon.
HEB 11:11 Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.
HEB 11:12 So from dis one man wey en body don die finish, shidren wey plenty rish stars for sky and san for wotaside kon full evriwhere.
HEB 11:13 All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.
HEB 11:14 Pipol wey tok like dis, show evribody sey dem dey espect dia own kountry.
HEB 11:15 Infact, if to sey dem dey tink of di kountry where dem from kom, dem for get mind to go back.
HEB 11:16 But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem.
HEB 11:17 Na faith make Abraham offa Isaak wen God dey test am. Even doh na God gi-am di pikin, e still ready to give di only pikin wey e get, back to God.
HEB 11:18 God tell am before sey, “True Isaak, yor family go many well-well.”
HEB 11:19 Dis na bikos Abraham bilive sey, even if Isaak die, God go raiz am from deat and true-true Abraham really kollect Isaak back from deat.
HEB 11:20 Na faith make Isaak bless Jakob and Esau about dia future.
HEB 11:21 Before Jakob die, na faith e take bless Josef shidren and woship God as e rest on-top en walkin stik.
HEB 11:22 Wen Josef life don dey end, na faith e take tok about di long travel wey Israel pipol go-go and e tell dem wetin dem go do with en bones.
HEB 11:23 Na faith make Moses papa and mama hide am wen dem born am, bikos dem si sey di pikin fine and dem nor fear to disobey wetin di king kommand.
HEB 11:24 Wen Moses kon grow up, na faith make am nor gri make dem koll am Fero dota pikin.
HEB 11:25 Instead of am to enjoy tins wey go make am sin, e kon choose to sofa with God shidren.
HEB 11:26 E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.
HEB 11:27 Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.
HEB 11:28 Na faith make Moses do di Passova and pour blood for pipol door-mot, so dat God angel wey dey kill all di first-born for Egypt, nor go tosh dem.
HEB 11:29 Na faith make Israel pipol cross di Red Sea like sey na dry land, but wen Egypt pipol try am, di wota swallow all of dem.
HEB 11:30 Na faith make Jeriko wall fall afta Israel pipol don mash round am for seven days.
HEB 11:31 Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
HEB 11:32 Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets,
HEB 11:33 na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;
HEB 11:34 kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem.
HEB 11:35 Some wimen wey dia pipol don die, na faith make dem receive dem back, alive. Some pipol rijet freedom kon die for sofa, so dat dem go fit wake-up from deat and enter life wey betta pass dis one.
HEB 11:36 Pipol laf some; flog some; shain some and put odas for prison.
HEB 11:37 Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow.
HEB 11:38 (Dis world nor good rish for dem); dem just dey waka about for wildaness, on-top mountins, inside rock and holes.
HEB 11:39 God praiz all of dem for dia faith, yet dem nor still get wetin God promise.
HEB 11:40 Bikos God plan sey, without us, dem nor go fit get di tins wey E promise dem.
HEB 12:1 Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.
HEB 12:2 Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.
HEB 12:3 If una dey tink how Jesus sofa for wiked pipol hand and how dem hate am, una mind go strong for faith.
HEB 12:4 As una dey struggol make una nor for sin, una struggol neva rish to kill una as Christ die.
HEB 12:5 Abi una don forget di advise wey God tell una as en shidren? “My pikin, make yu listin well-well wen God dey korrect yu and nor vex wen God ponish yu.
HEB 12:6 Bikos na di pesin wey God love, na-im E dey korrect and E dey ponish all di shidren wey bi en own.”
HEB 12:7 So make una bear as una dey sofa, since e bi sey na una Papa dey ponish una; dat one go show sey God dey trit una like en shidren. Abi e get pikin wey en papa nor dey ponish?
HEB 12:8 But if God nor ponish yu as e dey ponish all en shidren, dat mean sey yu nor bi betta pikin and yu nor get papa.
HEB 12:9 If awa papa for eart ponish us and wi dey respet dem, e nor good make God ponish us, so dat awa life go betta?
HEB 12:10 Awa papa dey ponish us for dis world as e good for dia eye, but God dey ponish us for awa own good, so dat wi go follow am share en holiness.
HEB 12:11 No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.
HEB 12:12 So una hands and knees wey don taya, make una make dem strong.
HEB 12:13 And make una waka for strait road, so dat una leg wey don taya, go strong.
HEB 12:14 Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.
HEB 12:15 Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.
HEB 12:16 Make una make sure sey nobody dey do bad tins or nor dey fear God, just like Esau wey sell en rite as first-born, bikos of food.
HEB 12:17 Una know how e try to get am back leta, but e nor fit, even doh e beg and kry give en papa.
HEB 12:18 Una don rish Mount Sinai, where God for tok to Israel pipol. For der, fire dey burn, darkness dey der and storm and
HEB 12:19 trumpet kon dey make nois. Israel pipol hear God vois, so dem beg am make E stop,
HEB 12:20 bikos dem nor fit bear en kommand wey sey, “Make una kill any animal wey tosh di mountin.”
HEB 12:21 Wetin happen dey make pesin fear, so Moses kon sey, “I dey fear and dey shake.”
HEB 12:22 Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly,
HEB 12:23 di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.
HEB 12:24 Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
HEB 12:25 Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?
HEB 12:26 For dat time, en vois dey shake di eart, but naw, E don promise sey, “Nor bi only dis eart I go shake, but I go shake di heavens too.”
HEB 12:27 Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain.
HEB 12:28 Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am.
HEB 12:29 Bikos awa God na big and strong fire wey dey distroy tins.
HEB 13:1 Make una dey love each oda like Christian brodas and sistas.
HEB 13:2 Make una always dey welkom strenja for una house, bikos like dis, some pipol don welkom angel enter dia house and dem nor know.
HEB 13:3 Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem.
HEB 13:4 Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.
HEB 13:5 Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”
HEB 13:6 So make wi get mind wey go make us fit sey, “Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin human being go fit do us?”
HEB 13:7 Make una remember una leaders wey tish una God word; make una tink about di kind life wey dem dey live, den make una follow dia faith.
HEB 13:8 Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
HEB 13:9 Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.
HEB 13:10 Wi get altar where di workers for di Tabanako nor fit chop from.
HEB 13:11 Di High Priest dey karry animal blood enter di Holy Place as ofrin for sins, but di animal body, na outside di kamp dem for dey burn am.
HEB 13:12 Derfor, Jesus take en own blood make sakrifice, so dat en pipol go dey holy. So Jesus Christ sofa outside di kamp too.
HEB 13:13 Wi must go meet am for outside di kamp kon share di shame with am.
HEB 13:14 Bikos for here, wi nor get any town wey go last, but wi dey wait di town wey go kom.
HEB 13:15 True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”
HEB 13:16 Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.
HEB 13:17 Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.
HEB 13:18 Make una pray for us, bikos wi dey sure sey awa mind klean and wi won live awa life for di korrect way.
HEB 13:19 Abeg, make una pray well-well, so dat dem go free mi and I go fit kom meet una soon.
HEB 13:20 God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,
HEB 13:21 make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
HEB 13:22 My brodas and sistas, I dey beg una, make una get patient and listin to di advise wey dey dis my leta, bikos wetin I rite, nor long.
HEB 13:23 Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una.
HEB 13:24 Make una greet all una leaders and all God pipol. God pipol for Italy dey greet una.
HEB 13:25 Make God grace dey with all of una.
JAM 1:1 Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.
JAM 1:2 My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon,
JAM 1:3 bikos una know sey, if una win di temptashon, una patient go strong.
JAM 1:4 And make una let patient do en work, so dat una go dey pafet and komplete, den una go gain evritin.
JAM 1:5 But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.
JAM 1:6 Di pesin wey dey ask, must get faith and make en mind nor shake, bikos anybody wey en mind dey shake, bi like river wey strong breeze dey blow up-and-down.
JAM 1:7 Make dat pesin nor tink sey e go receive anytin from God,
JAM 1:8 bikos e get doubol mind and e nor dey stabol for anytin wey e dey do.
JAM 1:9 Any biliver wey poor, make e happy, bikos God don lift am up.
JAM 1:10 But pesin wey get money, make e nor proud, bikos e go soon perish like flower wey dey for bush.
JAM 1:11 As sun dey dry grass and flower and dia beauti dey die forever, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and love money.
JAM 1:12 Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
JAM 1:13 Make nobody tok wen temptashon kom meet am sey, “God dey test mi,” bikos nor-tin fit tempt God and God ensef, nor dey tempt anybody.
JAM 1:14 But temptashon dey kom meet pesin wey get bad tins for mind.
JAM 1:15 Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.
JAM 1:16 My brodas and sistas, make nor-tin deceive una,
JAM 1:17 bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.
JAM 1:18 As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.
JAM 1:19 My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.
JAM 1:20 Human being vexnashon nor dey make pipol live di life wey God wont.
JAM 1:21 So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.
JAM 1:22 Make una nor dey deceive unasef as una dey hear God word, but make sure sey una dey do wetin en word tok.
JAM 1:23 Pesin wey hear God word and e nor dey do wetin e tok, bi like pesin wey dey look en face for mirror.
JAM 1:24 Wen di pesin look ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget how en face bi.
JAM 1:25 But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.
JAM 1:26 If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.
JAM 1:27 But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.
JAM 2:1 My brodas and sistas, since una get faith for awa Oga God Jesus Christ, make una nor dey do parsha.
JAM 2:2 If pesin wear gold ring and fine klot enter una church and poor pesin with dirty klot enter too
JAM 2:3 and una respet di one wey wear fine klot, kon tell am, “Sidan for betta place,” but una tell di poor pesin, “Stand der,” or “Sidan for groun.”
JAM 2:4 Dat mean sey una dey do parsha and kondemn pipol from una mind.
JAM 2:5 My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?
JAM 2:6 But una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opress and drag una go kourt?
JAM 2:7 Or dem nor dey tok bad about Jesus name wey una bilive?
JAM 2:8 But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat.
JAM 2:9 If una do parsha, una dey kommit sin and di law don kondemn una as pipol wey nor dey do wetin dey di law.
JAM 2:10 Di pesin wey dey do evritin wey dey di law and e break one, don break all of dem bi dat.
JAM 2:11 Bikos di same God wey sey, “Nor sleep with who yu nor marry,” naim still sey, “Nor kill anybody.” If yu nor sleep with who yu nor marry, but yu kill pesin, yu don break di law bi dat.
JAM 2:12 Make una tok and do like pipol wey dem go judge with di law wey go free pipol.
JAM 2:13 Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
JAM 2:14 My brodas and sistas, wetin dey good if pesin sey e get faith, but e nor dey do anytin? Dat kind faith go fit save am?
JAM 2:15 If one broda or sista nor get klot to wear or food to chop
JAM 2:16 and one pesin among una tell am, “Make peace dey with yu; make kold nor katch yu and make yu go chop beleful, but yu nor gi-am wetin di body wont, na wish kind good bi dat?”
JAM 2:17 Na so faith bi too, if yor faith nor dey produce betta result, e go die and dey yuzles.
JAM 2:18 If anybody sey, “I get faith and yu get work.” I go sey, “Make yu show mi yor faith wey nor get work and I go show yu my faith thru my work.”
JAM 2:19 Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
JAM 2:20 Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles?
JAM 2:21 Wen awa papa Abraham put en pikin Isaak for di altar, wetin e do dey good for God eye?
JAM 2:22 Yu nor si sey en faith and work dey togeda and na en work make en faith pafet?
JAM 2:23 And wetin dem rite for God word kon happen, “Abraham bilive wetin God tok and na dat one make am good for God eye, so God kon koll am, en friend.”
JAM 2:24 So, pesin work dey make am good too, nor bi only en faith.
JAM 2:25 Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di messenjas kon show dem anoda road wey dem go pass run?
JAM 2:26 Body wey nor get spirit don die, na so too, faith wey nor get work, don die.
JAM 3:1 My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass,
JAM 3:2 bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.
JAM 3:3 If wi tie rope for horse mout make e for obey us, dat mean sey wi dey kontrol en body.
JAM 3:4 Look ship for wota: E big well-well and na strong breeze dey fit push am, but na one small wheel di driver dey use take kontrol am.
JAM 3:5 Na so di tongue bi too: naim small pass for di body, but di tins wey e fit do big well-well. Make una tink how small fire fit burn big forest rish groun.
JAM 3:6 Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell.
JAM 3:7 Human being dey fit kontrol bird, animal wey dey creep for groun and animal wey dey stay for wota.
JAM 3:8 But nobody don ever fit kontrol en tongue well. Di tongue na bad tin wey nor dey stay one place, bikos e get poizin wey fit kill pesin.
JAM 3:9 Na di tongue wi take dey praiz awa Papa and Oga God Jesus Christ and naim wi still dey use take curse pipol wey God kreate like ensef.
JAM 3:10 My brodas and sistas, na di same tongue wi dey use take praiz and curse pipol. But e nor suppose bi like dat.
JAM 3:11 Wota wey dey kom out from groun, nor dey bring out fresh and bitter wota from di same place, abi e dey do so?
JAM 3:12 My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all.
JAM 3:13 Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.
JAM 3:14 But if jealousy and sefishnes dey en mind, make e nor boast and lie against di trut.
JAM 3:15 Dat kind wisdom nor kom from God, but e kom from dis eart wey wiked well-well.
JAM 3:16 Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too.
JAM 3:17 But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend.
JAM 3:18 Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.
JAM 4:1 Wetin dey make una kworel and fight? Nor bi di tins wey dey hongry una to do?
JAM 4:2 Yu wont sometin, but yu nor get am; yu dey kill, dey wont wetin oda pipol get and yu nor dey fit get am; so yu go kon dey kworel and fight. Yu nor get, bikos yu nor ask God make E give yu.
JAM 4:3 Wen yu ask for sometin, yu nor receive am, bikos yu nor ask well and yu won take am do wetin yu like.
JAM 4:4 Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.
JAM 4:5 Abi yu tink sey God nor mean wetin E tok wen E sey, “Di Spirit wey I put inside una dey jealous well-well?”
JAM 4:6 But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”
JAM 4:7 So, make yu give yorsef to God. But rijet di devil and e go run komot from where yu dey.
JAM 4:8 Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.
JAM 4:9 Make una kry and make sorrow dey una heart, den una go show sey una nor dey happy.
JAM 4:10 If una put una body down for God, E go karry una go up.
JAM 4:11 My brodas and sistas, make una nor tok bad about each oda. Anybody wey tok bad or judge en broda or sista for Christ, e dey tok bad about di law and e dey judge di law. But if una judge di law, den una nor dey obey di law, but una don bikom di law judge bi dat.
JAM 4:12 Na only one Pesin give di law and na-im bi judge. Na-im dey save and distroy. Yu wey dey judge yor neighbour, na who yu even tink sey yu bi?
JAM 4:13 Look, yu wey dey sey, “Today or tumoro, wi go-go dis or dat town go stay der for one year and do business kon get gain,”
JAM 4:14 but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.
JAM 4:15 Instead, yu suppose to sey, “If God wont, wi go dey alive and wi go do dis or dat tin.”
JAM 4:16 But as e bi so, yu dey boast dey karry body up. All dat kind boastin nor good.
JAM 4:17 So anybody wey know wetin good and e nor do am, don kommit sin bi dat.
JAM 5:1 Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.
JAM 5:2 Yor money don rotin and ants don chop yor klot.
JAM 5:3 Yor gold and silva don rust, dia ashes go tok against yu and chop yor flesh like fire. For di last days, yu don gada money and fine tins for yorsef!
JAM 5:4 Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.
JAM 5:5 Yu dey live life wey yu dey enjoy and yu dey enjoy for dis eart. Yu don make yorsef fat, dey wait for di day wey dem go kill yu.
JAM 5:6 Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.
JAM 5:7 My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
JAM 5:8 So, make una get patient too and make una heart strong, bikos di time wen Christ go kom back, don near.
JAM 5:9 My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.
JAM 5:10 Di profets wey God send kom tok to una, make una use dem as ezample to bear sofa and get patient.
JAM 5:11 Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.
JAM 5:12 My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.
JAM 5:13 If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.
JAM 5:14 If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name.
JAM 5:15 Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.
JAM 5:16 So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.
JAM 5:17 Elijah na human being like us and e pray with all en mind make rain nor fall. True-true, for three and half years, rain nor fall for dat place.
JAM 5:18 Den e pray again and di sky kon bring rain and evritin wey dem plant, kon grow.
JAM 5:19 My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,
JAM 5:20 make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.
1PE 1:1 Na mi Pita wey bi Jesus Christ apostle rite dis leta to di strenjas for Pontus, Galatia, Kappadocia, Asia aria and Bitynia wey God choose sey,
1PE 1:2 make dem dey holy thru en Spirit. Make una dey obey Christ for evritin and en blood go klean una. Make grace and peace bi una own!
1PE 1:3 Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.
1PE 1:4 Dem born us put for inheritance wey nor dey spoil, dirty or fade. God keep di inheritance for heaven for us
1PE 1:5 and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.
1PE 1:6 Aldo una go sofa small, but dis joy go bring happiness for una.
1PE 1:7 Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.
1PE 1:8 Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.
1PE 1:9 Una still get wetin make una faith strong and na dis bi di salvashon wey una soul get.
1PE 1:10 For dis salvashon matter, di profets wey tok before about di grace wey go kom, try well-well weda dem fit know wetin e mean, but dem nor fit.
1PE 1:11 Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.
1PE 1:12 Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.
1PE 1:13 So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.
1PE 1:14 Like shidren wey dey obey, make una stop di bad tins wey una dey do wen una neva know di trut.
1PE 1:15 But for evritin wey una dey do, make una dey holy like di Pesin wey koll una,
1PE 1:16 bikos God word sey, “Make una dey holy, bikos I dey holy.”
1PE 1:17 Since una dey koll God wey dey judge evribody akordin to wetin e do, “Papa”, make una live una life with respet for am.
1PE 1:18 Una know sey, God free una from di empty life wey una kollect from una grand-grand papa dem and E nor buy una with sometin wey fit spoil like silva or gold,
1PE 1:19 but na with Christ blood and na dis Christ bi God lamb wey nor get any mark or stain.
1PE 1:20 God choose am before E kreate dis world, but na for dis last days E show am to una.
1PE 1:21 True am, una bilive God wey raiz am from deat kon gi-am glory. So, una faith and hope dey for God hand.
1PE 1:22 Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.
1PE 1:23 God nor save una with human being body wey fit die, but na thru en word wey get life and dey forever.
1PE 1:24 Human being bi like grass and wetin make am fine, bi like flower; di grass go dry and di flower go die,
1PE 1:25 but God word go last forever. And na dis word bi di Good News wey dem prish give una.
1PE 2:1 Make una stop to do bad tin; dey deceive pipol, pritend; dey jealous and tok bad about pipol.
1PE 2:2 But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well
1PE 2:3 and una go know how God salvashon good rish.
1PE 2:4 Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye.
1PE 2:5 So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
1PE 2:6 God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.”
1PE 2:7 So, una wey bilive don know en value, but for di pipol and builders wey nor bilive, dat Stone don kon bi di main stone.
1PE 2:8 Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.
1PE 2:9 But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.
1PE 2:10 Before-before, una nor bi God pipol, but naw, una don bi en pipol. Dat time, God nor get mesi for una, but naw, una don get en mesi.
1PE 2:11 My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul.
1PE 2:12 So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.
1PE 2:13 Make una dey obey una leaders bikos of Christ. Weda dem bi kings wey get pawa
1PE 2:14 or govnors wey God choose sey, make dem ponish pipol wey do bad and praiz doz wey do good.
1PE 2:15 Bikos God wont sey, wetin una dey do, go make di pipol wey nor get sense shut up dia mout.
1PE 2:16 Make una live as free pipol and nor use una freedom as eskuse to do bad tins, but make una use am well as God savant.
1PE 2:17 Make una respet evribody. Love dis awa family wey bilive Christ. Make una fear God and respet di king.
1PE 2:18 Una wey bi slave, make una dey obey una oga, both di ones wey good or gentol and doz wey nor good.
1PE 2:19 If anybody bear pain bikos of God and dey sofa for wetin e nor do, God go favor am.
1PE 2:20 But why pipol go praiz yu wen dem ponish yu bikos of wetin yu do and yu bear-am? But if yu sofa bikos yu do good, God go favor yu,
1PE 2:21 bikos na wetin E koll yu to do, bi dat. Christ sofa as ezample wey una go follow
1PE 2:22 and e nor kommit any sin or lie.
1PE 2:23 Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.
1PE 2:24 E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”
1PE 2:25 Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.
1PE 3:1 Make una wey bi wife, dey obey una husband. Even doh dem nor dey do wetin dem rite for God word, di way una dey bihave, fit make dem shange,
1PE 3:2 wen dem si una good karata and how una life pure rish.
1PE 3:3 Make una beauti nor bi di one wey pipol dey only si like: to dey plait hair; dey wear gold or fine klot.
1PE 3:4 Instead make e show sey Christ dey inside una and una don get gentol and kwayet spirit wey God go value.
1PE 3:5 Di wimen for olden days dey holy, bikos dem put dia hope for God hand and dem respet dia husband.
1PE 3:6 As Sarah obey Abraham kon koll am, “My oga,” una go bi God pikin, if una dey do wetin good.
1PE 3:7 Husbands, make una dey trit una wife with soft hand, bikos una know sey dem nor strong rish una; make una respet dem as pipol wey get God grace and life. If una dey do like dis, nor-tin go block una prayers.
1PE 3:8 So, make una live for peace togeda, dey sorry for each oda; love one anoda and nor dey karry body up.
1PE 3:9 Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.
1PE 3:10 God word sey: Anybody wey won enjoy good life, must kontrol en mout; make e nor dey tok bad-bad tins or lie.
1PE 3:11 E must turn from di wikedness wey e dey do, kon start to do good and make e live for peace with evribody.
1PE 3:12 God dey si di pipol wey dey do good and en ear dey open to hear dia prayers. But E dey against pipol wey dey do bad.
1PE 3:13 Who go fit do yu bad tin, if yu dey do good?
1PE 3:14 But if yu sofa bikos yu dey do good, make yu nor fear doz wiked pipol, bikos God don bless yu bi dat.
1PE 3:15 For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.
1PE 3:16 But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.
1PE 3:17 E betta to sofa for wetin good, dan for bad one if na so God wont am.
1PE 3:18 Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.
1PE 3:19 As spirit, e kon go prish give wiked pipol spirits wey dey prison,
1PE 3:20 bikos dem nor do wetin God tok. God get patient for dem wen Noah dey build di ark, but na only di eight pipol wey dey inside di ark save from di wota.
1PE 3:21 Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up
1PE 3:22 go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.
1PE 4:1 Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again,
1PE 4:2 bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont.
1PE 4:3 Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju.
1PE 4:4 Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again.
1PE 4:5 For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem.
1PE 4:6 Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement.
1PE 4:7 Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.
1PE 4:8 As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.
1PE 4:9 Make una welkom pipol for una house without komplain.
1PE 4:10 God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.
1PE 4:11 Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!
1PE 4:12 My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen.
1PE 4:13 Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.
1PE 4:14 If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life.
1PE 4:15 But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.
1PE 4:16 But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name.
1PE 4:17 Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God?
1PE 4:18 If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God.
1PE 4:19 So if yu dey sofa as God wont am, make yu trust God wey kreate yu and E nor go ever fail yu.
1PE 5:1 Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:
1PE 5:2 Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.
1PE 5:3 And make una nor dey opress God pipol wey dey under una, instead make una bi ezample to dem.
1PE 5:4 So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.
1PE 5:5 For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.
1PE 5:6 Make una put una body for groun bikos of God and wen di rite time rish, E go karry una up.
1PE 5:7 Make una karry all una trobol give God, bikos E kare for una.
1PE 5:8 Make una shine una eye well-well, bikos devil wey bi una enemy, bi like hongry lion wey dey shaut and dey find who e go chop.
1PE 5:9 Make una nor gi-am shance, but make una faith strong, bikos una know sey na di same tin una brodas and sistas for evriwhere for dis world, dey sofa.
1PE 5:10 Afta una don sofa small, God wey koll una with en grace enter en glory for Christ, go make una komplete, una leg go strong and una go get pawa.
1PE 5:11 Make all pawa bi God own forever and ever. Amen!
1PE 5:12 I tell my dear broda Silas sey, make e help mi rite dis small leta, so dat una heart go strong and make e tell una sey, all wetin dey happen to una, na as God wont am. So make una stand strong with en pawa.
1PE 5:13 God pipol for di church wey dey Babilon dey greet una and Mark, my pikin, dey greet una too.
1PE 5:14 Make una salot each oda with Jesus Christ love. Make peace dey with all of una wey dey inside Christ.
2PE 1:1 Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.
2PE 1:2 Make God give una betta peace and grace as una dey grow for en word and inside Jesus, wey bi awa Oga God!
2PE 1:3 I pray make God pawa give us evritin wey wi nid, so dat wi go fit live di kind life wey E wont, as wi don know di trut about Jesus wey koll us with en glory and goodness.
2PE 1:4 Like dis too, wi don get betta promise and bikos of dat, wi go get God karata wey go free us from di bad tins wey dey for dis world.
2PE 1:5 So, make una try to make una faith strong and know God word. As una dey know God word more-more,
2PE 1:6 una go fit kontrol unasef; get patient; dey live holy life
2PE 1:7 and love una brodas and sistas without parsha.
2PE 1:8 Bikos if una really get dis tins, dem go dey grow inside una, so una nor go dey yuzles, but una go bear good fruits as una dey try to know Christ more-more.
2PE 1:9 But di pesin wey nor get dis tins, dey blind. Dis show sey, e nor dey si far and e don forget sey God don forgi-am en sins.
2PE 1:10 So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.
2PE 1:11 Di door to enter awa Oga God and Savior Jesus Christ kingdom, wey nor go ever end, go open wide for una.
2PE 1:12 I go dey remind una dis tins evritime, even doh I know sey una know dem and naw, una leg don strong for di trut wey una bilive.
2PE 1:13 As long as I dey, I look am sey e good make I dey remind una,
2PE 1:14 as I know sey di time wey I go die don near, bikos awa Oga God Jesus Christ don show mi.
2PE 1:15 I go try do evritin wey I fit do, so dat afta I don go, una go fit tok about dis tins.
2PE 1:16 Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.
2PE 1:17 God gi-am honor and glory wen di vois sey, “Dis na my Pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
2PE 1:18 Wen dis vois tok from heaven, wi awasef hear am, bikos wi dey with am on-top di mountin.
2PE 1:19 Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.
2PE 1:20 Di one wey important pass bi sey, una know dis tins: e nor get anytin wey di profets tok for God word wey just kom out from dia own mind,
2PE 1:21 bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.
2PE 2:1 As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.
2PE 2:2 Many pipol go follow dem live dia yeye life. Bikos of dis fake tishas, pipol go tok bad about di trut,
2PE 2:3 and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.
2PE 2:4 God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world.
2PE 2:5 God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.
2PE 2:6 E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life,
2PE 2:7 but E save Lot wey nor like wiked pipol life,
2PE 2:8 (bikos di time wey Lot dey dat town, e vex for di bad tins wey di pipol dey do).
2PE 2:9 If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.
2PE 2:10 Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,
2PE 2:11 even angels wey get pawa pass dem, nor dey tok about dis tins for God present.
2PE 2:12 But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.
2PE 2:13 Dem go sofa for dis tins wey dem dey do, bikos dem feel sey dem fit do anytin wey dia body wont for day time and wen ever dem follow una chop, dem dey kause trobol among una.
2PE 2:14 Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.
2PE 2:15 Since dem komot from di rite way, dem don miss road, bikos dem dey follow Balaam, Beor pikin, wey love bad tins!
2PE 2:16 As God dey korrect Balaam for en sin (donkey wey nor suppose tok kon tok to di profet, so dat e go stop di bad tins wey e dey do).
2PE 2:17 Dis pipol bi like river wey nor get wota, dem bi like kloud wey breeze dey blow anyhow and na dem God dey keep di place wey dark pass, dey wait.
2PE 2:18 Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins.
2PE 2:19 Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
2PE 2:20 Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.
2PE 2:21 Bikos e for betta sey, dem nor know God at-all, dan sey afta dem don know am, dem kon turn back from di kommandment wey God give dem.
2PE 2:22 Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”
2PE 3:1 My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una.
2PE 3:2 I wont make una remember all di word wey di profets tok before and di kommandment wey awa Oga God and Savior give us thru di apostles.
2PE 3:3 Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem.
2PE 3:4 Dem go sey, “I tink sey Jesus promise sey E go kom back? Awa grand-grand papa dem don die since, but evritin still bi as dem bi since God kreate di world.”
2PE 3:5 Dem don forget sey, na with word God take kreate di heaven before E kreate di eart from wota and na with wota, E take make dis world.
2PE 3:6 And na with di same wota, E take distroy di eart wey dey before.
2PE 3:7 Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.
2PE 3:8 Naw, my friends, make una nor let dis tin pass una, bikos one day bi like 1,000 years for God eye and 1,000 years bi like one day.
2PE 3:9 Nor bi sey God nor fit do wetin E promise as some pipol dey tink, but E dey patient dey wait for una, bikos E nor wont make anybody die trowey, but E wont make evribody turn from sin kom meet am.
2PE 3:10 Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.
2PE 3:11 Since evritin go melt like dis, wish kind pipol wi suppose to bi? E good make wi dey live awa life for holiness and dey do wetin God wont.
2PE 3:12 Since wi dey wait for di day wey Christ go kom, make wi dey do wetin wi fit do to make Christ kwik kom. Bikos for dat day, evritin wey dey for heaven go burn kon skata and di stars, go melt.
2PE 3:13 But as God promise, wi dey wait for di new heaven and eart, di place where raitiousness dey.
2PE 3:14 So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.
2PE 3:15 God dey wait with patient, so dat una go turn from sin kom meet am, just as awa broda Paul rite give una akordin to di wisdom wey God gi-am.
2PE 3:16 E tok about dis tins for all en letas. Aldo some tins for di leta dey hard to undastand and doz wey nor know di trut or dey stabol, don turn dem to wetin go kill dem. Na so dem take distroy all di oda part for God word too.
2PE 3:17 So, my friends, as una don know wetin go happen, make una shine una eye, so dat una nor go miss di way and fall from di trut wey una get, bikos na so pipol wey nor sirious, dey do.
2PE 3:18 But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
1JO 1:1 Di tin wey dey from di biginnin, wey wi don hear and si with awa eye; wey awa hand don tosh (tins wey koncern di word wey dey give life
1JO 1:2 and dis life kom out and wi don si am. Na dis tins wi dey tok about. Wi dey tell una about di life wey nor dey end, wey dey with di Papa for heaven and E don show am to us.
1JO 1:3 Na wetin wi don si and hear, wi dey tell una, so dat una go fit bi awa friend, just as wi bi friend with di Papa and en Pikin.)
1JO 1:4 Na dis make us dey rite dis leta, so dat awa joy go full well-well.
1JO 1:5 Na di message wey wi hear from am, naim wi dey tell una so: Na God bi lite and darkness nor dey inside am at-all.
1JO 1:6 If wi sey wi bi en friend and wi still dey inside darkness, wi dey lie and trut nor dey awa mout.
1JO 1:7 But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.
1JO 1:8 If wi sey wi nor get sin, wi dey deceive awasef and di trut nor dey inside us.
1JO 1:9 But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.
1JO 1:10 If wi sey wi nor dey sin, dat mean sey, God dey lie and di trut nor dey inside us.
1JO 2:1 (My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious
1JO 2:2 and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.
1JO 2:3 Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am.
1JO 2:4 Di pesin wey sey, “I know God” and e nor dey do wetin God tok, dat pesin dey lie and di trut nor dey inside am.
1JO 2:5 But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.
1JO 2:6 Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.
1JO 2:7 Una wey bi my friends, I nor dey rite new kommandment give una, na di old one wey una get from di biginnin, I still dey rite and una don hear dem before.
1JO 2:8 But dis new kommandment wey I dey rite give una so, naim bi di trut wey dey show inside Christ and inside una, bikos darkness don pass and di real lite don dey shine.
1JO 2:9 Pesin wey sey e dey inside di lite, but e still hate en broda or sista for Christ, dat pesin still dey inside darkness.
1JO 2:10 Pesin wey love en broda or sista for Christ, dey live inside di lite and nor-tin go make am fall.
1JO 2:11 But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.
1JO 2:12 My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name.
1JO 2:13 I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan.
1JO 2:14 I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.
1JO 2:15 Make una nor love dis world or di tins wey dey inside am. If anybody love dis world, di Papa love nor dey inside am,
1JO 2:16 bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.
1JO 2:17 And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey forever.
1JO 2:18 My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.
1JO 2:19 Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
1JO 2:20 But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true.
1JO 2:21 I nor rite give una, bikos una nor know di trut, but na bikos una know Christ and di trut dey stay inside am.
1JO 2:22 Na who dey lie? Na di pesin wey sey Jesus nor bi di Mezaya! Di pesin wey rijet di Papa and en Pikin, na Christ enemy.
1JO 2:23 Anybody wey rijet di Pikin, nor get di Papa. But if pesin asept di Pikin, e don asept di Papa too.
1JO 2:24 As for una, wetin una don hear from di biginnin, make una let am stay inside una. If wetin una hear from di biginnin stay inside una, una go stay inside di Pikin and en Papa.
1JO 2:25 Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end.
1JO 2:26 Na dis tins I dey rite give una about pipol wey dey try to deceive una.
1JO 2:27 As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.
1JO 2:28 Naw my shidren, make una stay inside am, so dat wen E kom, awa heart go dey strong well-well and shame nor go make us run from where E dey.
1JO 2:29 If una know sey E dey raitious, den una go know sey, doz wey dey do wetin God wont, na en shidren dem bi.
1JO 3:1 Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.
1JO 3:2 My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
1JO 3:3 And evribody wey get dis hope for Christ, dey make ensef pure, just as Jesus dey pure.
1JO 3:4 Evribody wey dey like to sin, nor dey obey God law and to sin, na to disobey God law.
1JO 3:5 And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.
1JO 3:6 Anybody wey dey stay inside am nor dey like to sin, but pesin wey dey kommit sin, neva si or know am.
1JO 3:7 So my shidren, make una nor let anybody deceive una: If pesin dey do wetin good for God eye, dat show sey dat pesin dey good, just as Christ dey good for God eye.
1JO 3:8 But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.
1JO 3:9 Pesin wey bi God pikin, nor dey like to sin, bikos God seed dey inside am.
1JO 3:10 Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.
1JO 3:11 Dis na di Good News wey una don hear from di biginnin sey, “Make wi love each oda as awasef.”
1JO 3:12 Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.
1JO 3:13 So my brodas and sistas, make una nor sopraiz sey dis world pipol hate una.
1JO 3:14 Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.
1JO 3:15 Pesin wey hate en broda or sista for Christ, fit kill pesin and di life wey nor go end, nor dey inside am.
1JO 3:16 Dis na wetin make us know wetin love bi: Jesus Christ die for us, so wi suppose sakrifice awa life for awa fellow Christian brodas and sistas.
1JO 3:17 But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?
1JO 3:18 My shidren, make wi nor dey love with only word for mout, but make wetin wi dey do, show sey wi really love each oda.
1JO 3:19 Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present.
1JO 3:20 So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.
1JO 3:21 My friends, if awa mind nor kondemn us, awa heart go strong for God present
1JO 3:22 and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am.
1JO 3:23 Na wetin E kommand bi dis, “Make wi bilive en pikin Jesus Christ name and make wi love each oda, even as E don kommand us.”
1JO 3:24 So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.
1JO 4:1 My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.
1JO 4:2 Dis na how una go take know God Spirit: If pesin bilive sey na Jesus bi di Mezaya, wey kom as human being, dat pesin get God Spirit.
1JO 4:3 But evribody wey nor gri sey Jesus na Oga God, dat pesin spirit nor kom from God. Dat na di anti-Christ spirit wey una hear sey dey kom and e don already dey dis world.
1JO 4:4 My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.
1JO 4:5 Dem kom from dis world: so dem dey tink like pipol for di world and di pipol wey dey di world, dey listin to dem.
1JO 4:6 Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.
1JO 4:7 My friends, make wi love one anoda, bikos love kom from God and anybody wey love odas, na God pikin and e know God,
1JO 4:8 but pesin wey nor love en broda nor know God, bikos God na love.
1JO 4:9 Dis na how God love dey show for awa life: God send en only Pikin wey E born, make e kom dis world, so dat thru am, wi go get life wey nor dey end.
1JO 4:10 Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.
1JO 4:11 My friends, if God love us like dis, den wi must love each oda.
1JO 4:12 Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us.
1JO 4:13 God don give us en Spirit to show sey wi dey inside am and e dey inside us.
1JO 4:14 Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.
1JO 4:15 If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too.
1JO 4:16 Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us.
1JO 4:17 And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world.
1JO 4:18 Dis kind love nor get fear, bikos betta love dey drive fear komot from pesin heart. If wi dey fear bikos wi nor wont make God ponish us, dat show sey wi neva really know how en love bi.
1JO 4:19 Bikos God first love us, naim make us dey fit love each oda.
1JO 4:20 If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?
1JO 4:21 God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”
1JO 5:1 Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.
1JO 5:2 Wi go know sey wi love God shidren, wen wi love God and obey en kommandment.
1JO 5:3 To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.
1JO 5:4 Anybody wey bi God pikin, don win di world and na awa faith bi di pawa wey win di world.
1JO 5:5 Pesin wey bilive sey Jesus Christ na God Pikin, don win di world.
1JO 5:6 Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.
1JO 5:7 Wi get three witness to show sey wetin wi dey tok, na true and dem bi:
1JO 5:8 God Spirit, di wota and di blood and dis three witness dey tok di same tin.
1JO 5:9 If wi gri sey wetin human being tok na true, den wetin God tok about en pikin, naim big pass.
1JO 5:10 (Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).
1JO 5:11 Dis na wetin God tok: God don give us life wey nor dey end and dis life dey inside en Pikin.
1JO 5:12 Anybody wey get di Pikin, get di life wey nor go end, but doz wey nor know God Pikin, go die.
1JO 5:13 I don rite all dis tins give una wey bilive God Pikin, so dat una go know sey una get life wey nor go end.
1JO 5:14 Na dis tins dey make awa mind strong anytime wey wi kom meet God: bikos if wi ask am for anytin wey dey good for en eye, E go give us.
1JO 5:15 And if wi know sey E dey hear us, den wi bilive sey wi go get di tins wey wi ask from am.
1JO 5:16 If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.
1JO 5:17 Evritin wey nor good for God eye, na sin, but e get di sins wey nor dey kause deat.
1JO 5:18 Wi know sey anybody wey bi God pikin, nor dey like to sin, but God dey keep en pikin, so dat devil nor go fit tosh am.
1JO 5:19 Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.
1JO 5:20 Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.
1JO 5:21 So my shidren, make una make sure sey una nor get anytin to do with oda gods.
2JO 1:1 Mi wey bi elder dey rite dis leta to di woman wey God choose, with en shidren wey I love inside di trut (nor bi only mi, but na evribody wey know di trut).
2JO 1:2 Bikos di trut dey inside us, e go stay inside us forever.
2JO 1:3 Make God, awa Papa and Jesus Christ, en pikin wey dey inside trut and love, give us grace, mesi and peace.
2JO 1:4 I dey happy well-well, wen I si sey some among yor shidren dey live akordin to di trut, just as di Papa kommand us.
2JO 1:5 I dey rite to remind una sey, make una love one anoda. Dis nor bi new kommandment, but na di one wey dey from di biginnin.
2JO 1:6 (Na wetin love mean bi dis: make wi dey do wetin God wont.) Na di kommandment bi dis and just as wi hear am from di biginnin; na so wi suppose to follow am.
2JO 1:7 Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!
2JO 1:8 Make una shine una eye, so dat di work wey wi do among una, nor go lost, but instead, wi go get komplete reward.
2JO 1:9 Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.
2JO 1:10 If anybody kom meet una and e nor asept wetin wi dey tish, make una nor welkom or receive am as una broda.
2JO 1:11 But pesin wey receive am, go dey follow am do di wiked tins wey e dey do.
2JO 1:12 Even doh I get many oda tins wey I won tell una, I nor won take paper and biro rite dem, but I hope sey I go kom visit una and I go tok to una face-to-face, so dat awa happiness go full.
2JO 1:13 Una sista shidren wey God don choose, dey greet una.
3JO 1:1 Mi wey bi elder dey rite dis leta to Gaius, my broda wey I love well-well.
3JO 1:2 My friend, I dey pray sey make evritin dey good for yu and make yor body well, just as yor soul well too.
3JO 1:3 I happy well-well wen awa brodas kom tok about how yu dey always live for di trut.
3JO 1:4 Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.
3JO 1:5 My friend, di tins wey yu dey do for awa brodas wey yu nor even know, good well-well.
3JO 1:6 Dem don even tok about yor love for inside di church where God pipol gada. E go good sey wen dem kom yor side, make yu help dem, so dat belle go sweet God as dem dey kontinue dia journey.
3JO 1:7 Dem start dia journey bikos of “Christ name” and dem nor gri take anytin from pipol wey nor bi Christian.
3JO 1:8 So wi suppose to help doz pipol, so dat wi go bi dia ko-worker wey go make di trut stand.
3JO 1:9 I bin rite leta to di church pipol, but Diotrefes, wey dey karry body up sey na-im bi dia leader, nor gri welkom us.
3JO 1:10 So, wen I kom, I go tell evribody wetin e do; tins wey wi nor do and e sey wi do am. Even doh e dey tok bad about us, dat one nor do for am; nor bi only sey e nor dey welkom awa brodas, but e dey make odas nor welkom dem too and e dey drive dem komot from di church.
3JO 1:11 My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.
3JO 1:12 Pipol don tok about Demetrius, bikos e dey do good and even di trut wey e know, show sey e good. Wisef dey tok about how e good and yu know sey wetin wi dey tok, na true.
3JO 1:13 I get many tins wey I won tell yu, but I nor one rite dem with biro and paper.
3JO 1:14 I dey hope sey I go soon si yu and wi go tok face-to-face.
3JO 1:15 Make peace dey with yu. Awa friends for here dey salot yu too. Make yu greet all awa friends wey dey der.
JUD 1:1 Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.
JUD 1:2 Make mesi, peace and love dey with una!
JUD 1:3 My friends, even doh e don dey hongry mi since to rite give una about di salvashon wey wi dey share togeda, naw e strong well-well for my mind to rite, so dat una mind go dey strong. So una go fit stand fight for wetin wi bilive; di tins wey God don give en pipol and nor-tin go fit shange am.
JUD 1:4 Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.
JUD 1:5 So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.
JUD 1:6 And I still dey remind una about di angels wey nor stay for where God put dem, but kon komot for where dem suppose dey. God don shain dem tie for darkness until wen E go judge di world.
JUD 1:7 Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.
JUD 1:8 Like dis too, dis men wey sey dem dey dream; dey live bad life; dem nor dey obey God authority and dem even dey curse angels wey get glory.
JUD 1:9 But wen Mikael, di big angel dey kworel with devil bikos of Moses body, e nor curse am, but instead, e sey, “Na God go judge yu!”
JUD 1:10 But dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem suppose to undastand without sey pesin tish dem. As animals nor dey tink before dem do tins, na so dis pipol dey bihave.
JUD 1:11 Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.
JUD 1:12 Wen dis pipol dey follow una chop di fellowship food wey God don bless, dem bi like shuku-shuku for una body. Dem bi like shepad wey nor dey shame, bikos e kare for only ensef. Dem bi like kloud wey just dey blow, but rain nor dey fall. Dem bi like tree wey nor get fruits and God don rut dem komot from groun.
JUD 1:13 Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.
JUD 1:14 Enoch wey bi di nomba seven pesin afta Adam, profesai about dis pipol. E sey, “Listin! God dey kom with en holy pipol wey nobody fit kount and
JUD 1:15 e dey kom judge evribody, so dat pipol go know di bad tins wey dem dey do and di wiked words wey sinnas don tok against God.”
JUD 1:16 Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.
JUD 1:17 But my friends wey I love, make una remember wetin awa Oga God Jesus apostles tell una.
JUD 1:18 Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”
JUD 1:19 Dis kind pipol dey divide God pipol; dem like dis world tins and dem nor get God Spirit.
JUD 1:20 My friends, make una dey build unasef up with faith wey holy well-well and dey pray with di Holy Spirit.
JUD 1:21 Make una keep unasef inside God love as una dey wait for awa Oga God Jesus Christ, wey go bring life wey nor go end.
JUD 1:22 And make wi help doz wey dia faith dey shake.
JUD 1:23 Make una help odas make dem nor enter hell-fire, so dat una go fit save dem and as una dey help odas, make una dey fear God kon hate di tins wey go make una sin.
JUD 1:24 Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.
JUD 1:25 Make all glory, majesty, pawa and authority, bi God own, naw and forever thru Christ wey bi awa Oga God. Amen!
REV 1:1 Dis vishon na from Christ and na God sey make e show en savants wetin go soon happen. E make am klear thru di angel wey E send kom meet John
REV 1:2 and John bear witness for evritin wey e si. Dis na wetin John tok koncerning God word and about Jesus Christ.
REV 1:3 Di pesin wey go read dis profesy give pipol, God go bless am. God go bless doz wey dey listin and do wetin dem rite for di profesy, bikos di time don near.
REV 1:4 Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front
REV 1:5 and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;
REV 1:6 di one wey give us betta kingdom kon make us priest wey go dey serve God wey bi en Papa, make glory and pawa bi en own forever and ever! Amen.
REV 1:7 (Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)
REV 1:8 God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”
REV 1:9 Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.
REV 1:10 On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,
REV 1:11 “Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”
REV 1:12 I turn make I si di pesin wey dey tok to mi and wen I turn, I kon si seven lampstand wey dem take gold make.
REV 1:13 And di pesin wey stand for di lampstand centre, bi like Man Pikin. E wear long dress with gold belt for en waist.
REV 1:14 En head and hair white like wool, dem even white rish snow and en eyes red like fire wey dey burn well-well.
REV 1:15 En legs bi like bronze wey dem polish for fire and en vois bi like di nois wey sea dey make.
REV 1:16 E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.
REV 1:17 Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,
REV 1:18 di One wey dey alive! I die before, but naw, I dey alive forever and ever. Deat and grave key dey my hand.
REV 1:19 So make yu rite wetin yu si: both doz wey go happen naw and di ones wey go happen leta.
REV 1:20 Di seven stars wey yu si for my rite hand, na dia sekret bi dis: Di stars na di angels for di seven church and di seven lampstand, na di seven church.”
REV 2:1 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Efesus: ‘Di Pesin wey whole di seven stars for en rite hand and dey waka round di seven lampstand, dey tell di pipol for di church sey:
REV 2:2 I know yor work. I don si evritin wey yu do and even as yu dey wait with patient. I know sey yu nor like wiked pipol. Yu don test pipol wey sey dem bi apostles, but dem nor bi, bikos yu si sey, dem dey lie.
REV 2:3 I still know sey yu don bear many tins bikos of my name and still, yu neva taya.
REV 2:4 But dis na wetin I get against yu: di way yu love mi naw, nor strong rish as e bi before!
REV 2:5 So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.
REV 2:6 But all dis tins dey happen make e for betta for yu, bikos yu hate di tins wey Nikolaitan pipol dey do and I hate doz tins too.
REV 2:7 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”
REV 2:8 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Smyrna: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di First and di Last, di One wey die kon kom back to life.
REV 2:9 I know di sofa wey yu sofa and how yu nor get money, but yu get enough money. I still know di bad tins wey dem tok about yu. Dem sey dem bi Jew pipol, but dem nor bi Jew, bikos dia sinagog, na Satan own.
REV 2:10 Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.
REV 2:11 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, di sekond deat nor go kill-am.’ ”
REV 2:12 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Pergamum: ‘Dis na di message from di Pesin wey whole di swod wey get two sharp side.
REV 2:13 I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.
REV 2:14 But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.
REV 2:15 Like dis too, some pipol among una dey follow wetin Nikolaitan pipol dey tish.
REV 2:16 So, make yu turn from sin kom meet God! If not, I go kwik-kwik kom fight yu with di swod wey dey my mout.
REV 2:17 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”
REV 2:18 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Tiatira: ‘Dis message na from God Pikin wey en eye red like fire wey dey burn well-well and en legs bi like bronze wey dem polish:
REV 2:19 I know all di tins wey yu dey do. I don si yor love, yor faith, yor work and as yu dey wait with patient. And I si as yu dey do well for all dis tins.
REV 2:20 But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.
REV 2:21 I don gi-am time make e turn from sin kom meet God, but e nor gri stop to sleep with doz wey nor bi en husband.
REV 2:22 Si! I go trow am put for bed where e go sofa and doz wey dey sin with am, go sofa well-well, unless dem turn from sin kom meet God.
REV 2:23 I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.
REV 2:24 But una wey dey Tiatira, wey nor dey follow wetin Jezebel dey tish (wey neva learn di tins wey dem dey koll “Satan deep sekret”), I dey tell una dis tins naw, but I nor go ask una for anytin again.
REV 2:25 Make una whole wetin una get until I kom.
REV 2:26 Anybody wey fit bear and obey mi rish di end, I go gi-am authority ova all di nashons.
REV 2:27 E go rule di nashons with iron rod kon break dem to pieces like pot.
REV 2:28 E go get di same authority wey I get from my papa and I go still gi-am di star wey dey shine for morning.
REV 2:29 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
REV 3:1 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Sardis: ‘Di Pesin wey whole God seven spirits and di seven stars: I know wetin yu dey do; for pipol eye, yu dey alive, but true-true, yu don die.
REV 3:2 So make yu raiz-up kon give pawa to di remainin tins wey don nearly die, bikos yor work nor dey good for God eye.
REV 3:3 Make yu remember wetin yu don hear and receive and make yu obey dem kon turn from sin kom meet God. If yu nor shine yor eye well, I go kom like tif and yu nor go know di time wen I go kom.
REV 3:4 But yu get some pipol for Sardis wey neva stain dia klot, dem go wear white klot follow mi waka, bikos dem deserve am.
REV 3:5 Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.
REV 3:6 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
REV 3:7 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.
REV 3:8 I know evritin wey yu dey do. (Si, I don open door for yu wey nobody go fit klose.) I know sey yu nor too get pawa, but yu don obey my word and yu nor deny mi at-all.
REV 3:9 Listin! Doz pipol from Satan sinagog wey lie sey dem bi Jew, I go make dem bow for yor front, den dem go know sey I really love yu.
REV 3:10 Bikos yu don obey my kommandment wey bi to get patient, I go protet yu wen I won test evribody for dis world.
REV 3:11 I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.
REV 3:12 Anybody wey fit bear rish di end, I go make am pila for my Papa Temple and e nor go ever komot from der. I go rite my Papa name; David Town; di new Jerusalem wey dey kom from heaven and my own new name, put for en body.
REV 3:13 Anybody wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
REV 3:14 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.
REV 3:15 I know evritin wey yu do. Yu nor dey hot or kold. I wish sey yu hot or kold!
REV 3:16 But since yu just dey warm and yu nor hot or kold, I go vomit yu komot from my mout!
REV 3:17 Bikos yu dey sey, “I get plenty money and I nor nid anytin!” But yu nor know sey yor kondishon bad well-well, yu dey sofa; yu poor; blind and naked.
REV 3:18 So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.
REV 3:19 I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!
REV 3:20 Listin! I stand for di door dey nok! If anybody hear my vois, kon open di door, I go enter go meet am, kon follow am chop and e go chop with mi too.
REV 3:21 Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.
REV 3:22 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
REV 4:1 Afta all dis tins, I look up kon si one door wey open for heaven! Den di vois wey I first hear kon tok to mi like loud trumpet sey: “Make yu kom up, so dat I go show yu wetin go happen afta dis tins.”
REV 4:2 So for di vishon, I si one throne for heaven wey pesin sidan put!
REV 4:3 Di pesin wey sidan for di throne bi like jasper and karnelian stone. Rainbow dey round di throne and e bi like sey dem make am with emerald stone.
REV 4:4 Twenty-four oda thrones dey round di first throne and twenty-four eldas sidan put for di thrones. Dem wear white klot and gold crown dey dia head.
REV 4:5 Lite dey shine kom out from di throne and tonda dey make nois from am too. For di throne front, seven tosh wey get fire dey burn for der. Dis na God seven spirit.
REV 4:6 Di throne front dey shine like mirror and e bi like crystal. For centre and around di throne, for creatures wey get eye full body, dey for der too.
REV 4:7 Di first one bi like lion, di sekond one bi like melu, di third one get human being face and di fourt one bi like eagle.
REV 4:8 Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.
REV 4:9 Wen ever di for creatures dey tank, praiz and honor di Pesin wey sidan for di throne wey dey alive forever and ever,
REV 4:10 di twenty-four eldas go bow woship di Pesin wey dey live forever and ever. Dem go remove dia crown put for en throne front kon sey:
REV 4:11 “Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”
REV 5:1 Den I si sey di Pesin wey sidan for di throne, hold one book for en rite hand. Dem rite sometin put for di front and back kon lock am with seven keys.
REV 5:2 Den I si one strong angel dey shaut with loud vois sey: “Na who dey holy rish to break di keys and open dis book?”
REV 5:3 But nobody for heaven, eart or under eart fit open di book or look inside.
REV 5:4 So I start to kry, bikos nobody dey holy rish to open di book or look inside.
REV 5:5 Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”
REV 5:6 Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.
REV 5:7 Den e waka go kollect di book from di Pesin wey sidan for di throne.
REV 5:8 And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers.
REV 5:9 Dem kon dey sing new song sey: “Yu holy rish to take di book kon open di keys, bikos dem kill yu and na yor blood save all God pipol from evry tribe, language, group and kountry.
REV 5:10 Yu don choose dem as kings and priests wey go serve God and dem go rule for di eart.”
REV 5:11 As I dey look, I kon hear many tazon angels vois as dem stand round di throne; di for creatures and di eldas.
REV 5:12 All of dem kon dey sing with loud vois sey: “Di Lamb wey dem kill, make glory, pawa, propaty, wisdom and honor, bi en own!”
REV 5:13 Den I hear evritin wey God kreate for heaven, eart, under eart, sea and evritin wey dey inside dem dey sing sey: “Make praiz, honor, glory and pawa to rule, bi di Pesin wey sidan for di throne and di Lamb own, forever and ever!”
REV 5:14 And di for creatures kon sey, “Amen!” Den di eldas fall face groun kon start to woship God.
REV 6:1 As I dey look, di Lamb kon open one for di seven keys and I hear one for di for creatures dey shaut like tonda sey, “Make yu kom!”
REV 6:2 So I look kon si one white horse dey kom! Di pesin wey dey ride am whole bow and e wear crown for en head. E go fight and win many war and na champion e bi.
REV 6:3 Wen di Lamb open di sekond key, I kon hear di sekond creature dey sey, “Make yu kom!”
REV 6:4 Den anoda red horse kom out. Dem give di pesin wey dey ride am, big swod and pawa to take remove peace from dis eart. So pipol kon dey fight and kill each oda for evriwhere.
REV 6:5 Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand.
REV 6:6 Den I hear one vois among di for creatures dey sey, “Dem dey sell six pound for barley and one bread for only one penny and make yu nor spoil di olive oil and wine.”
REV 6:7 Wen di Lamb open di fourt key, I hear di fourt creature dey sey, “Make yu kom!”
REV 6:8 So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.
REV 6:9 Wen di Lamb open di fift key, pipol wey dem don kill bikos of God word and wetin dem dey tok about Christ, I si dia soul for under di altar.
REV 6:10 Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”
REV 6:11 Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.
REV 6:12 Den di Lamb open di sixt key and big eartkweke kon happen. Di sun kon dark like black klot and di moon kon dey red like blood.
REV 6:13 Di stars for sky fall kom groun like di way fig tree fruit wey ripe, dey fall wen strong breeze dey blow.
REV 6:14 Di sky kon dey fold like paper and evry mountin and island move komot from where dem dey before.
REV 6:15 Den evribody, both di kings for di eart; di rulers; ofisas; doz wey get money; doz wey get pawa and evry slave and free pesin kon hide demsef for holes and among di mountins.
REV 6:16 Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.”
REV 6:17 Bikos di day to ponish dem, don kom and nobody go survive am.
REV 7:1 Den, I si for angels stand for di for korna for di eart and dem whole di for breeze, so dat e nor go blow for di eart, di sea or for any tree.
REV 7:2 Den I si anoda angel dey kom down from di east. E karry God key, den e kon shaut give doz for angels wey dem don give pawa to ponish land and sea sey,
REV 7:3 “Make una wait! Make una nor ponish di land, sea or di trees, until wi don put God mark for en savants fore head.”
REV 7:4 Den I hear di nomba wey dem put God mark for dia fore head. Dem bi 144,000 from all di tribes for Israel:
REV 7:5 Dem mark 12,000 from Judah tribe, 12,000 from Reuben tribe, 12,000 from Gad tribe.
REV 7:6 And from Asher tribe, na 12,000 dem mark, 12,000 from Naftali tribe, 12,000 from Manasseh tribe,
REV 7:7 12,000 from Simeon tribe, 12,000 from Levi tribe, 12,000 from Issakar tribe,
REV 7:8 12,000 from Zebulun tribe, 12,000 from Josef tribe and 12,000 from Benjamin tribe.
REV 7:9 Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand
REV 7:10 dey shaut sey: “Awa God wey sidan for di throne and di Lamb, na yu get pawa to save pipol!”
REV 7:11 And all di angel stand round di throne; di eldas and di four creatures. Dem fall face groun kon bigin woship God.
REV 7:12 Dem kon dey sey: “Make praiz, glory, wisdom, tanks, honor, authority and pawa bi awa God own forever and ever. Amen!”
REV 7:13 Den one for di eldas kon ask mi sey, “Dis pipol wey wear long white klot so, where dem from kom?”
REV 7:14 I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!
REV 7:15 Dis na why dem stand for God throne front kon dey serve am for en Temple, both for nite and day time.
REV 7:16 Hongry nor go ever katch dem again. Dem go always get wota to drink; sun nor go ever beat dem again.
REV 7:17 Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”
REV 8:1 Wen di Lamb open di sevent key, evriwhere for heaven kon kwayet for like thirty minutes.
REV 8:2 Den I si seven angels wey stand for God present and E give dem seven trumpets.
REV 8:3 Den anoda angel whole gold plate for hand kon stand near di altar. And God sey make e mix many incense join God pipol prayers and e go bi ofrin before di gold altar.
REV 8:4 Di smoke from di incense, plus God pipol prayers kon dey go up go meet God from di angel hand.
REV 8:5 Di angel take di basin wey dem dey burn incense put kon pak fire full am from di altar, den e trow am kom di eart and tonda with strong lite and heavy eartkweke kon happen.
REV 8:6 Di seven angels wey whole di seven trumpets dey ready to blow dem.
REV 8:7 Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.
REV 8:8 Den di sekond angel blow en trumpet and dem trow mountins wey fire dey, enter di sea. If dem divide di sea into three, one part kon turn to blood.
REV 8:9 And wen dem divide evritin wey get life for di sea into three, one part die finish. Den wen dem divide all di ship for di world into three, one part burn finish too.
REV 8:10 Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part.
REV 8:11 Di star name na “Bitterness.” So if dem divide di wota into three, one part betta and di wota kon kill pipol wey drink from am.
REV 8:12 Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.
REV 8:13 Den I look and I hear one eagle dey shaut as e dey fly for sky, “E go bad well-well! E go bad well-well! E go bad well-well for pipol wey dey dis eart, bikos of wetin go happen wen di last three angels go blow dia trumpets.”
REV 9:1 Den di fift angel blow en trumpet and I si one star wey fall from heaven kom eart and dem gi-am di key wey e go use take open di pit.
REV 9:2 Wen e open am, smoke kom out like fire kon turn di sun and breeze to darkness.
REV 9:3 From inside di smoke, grasshoppa bigin enter di eart and dem give dem pawa like skorpion own.
REV 9:4 Di angel tell dem, “Make una nor distroy di grass, plants and trees, but distroy only di pipol wey God mark nor dey dia fore head.”
REV 9:5 E still tell dem, “Nor kill di pipol wey nor get God mark for dia forehead, but make una sofa dem for five monts with pain wey bi like skorpion own.”
REV 9:6 For dat time, pipol go look for deat, but dem nor go si am. Dem go won die, but deat go run from dem.
REV 9:7 Di grasshoppa bi like horse wey dey ready for war. Wetin dey dia head, bi like gold crown and dia face bi like human being own.
REV 9:8 Dia hair bi like wimen hair and dia tit bi like lion own.
REV 9:9 Wetin dem wear bi like bullet proof wey dem make with iron and dia feada dey make nois like horse wey dey go fight.
REV 9:10 Dia tail dey bite like skorpion own and di angel give dem pawa to sofa pipol for five monts.
REV 9:11 Na dia king bi di angel wey kom from di pit and en name for Hibru, na Abaddon and for Greek, na Apollon (pesin wey dey distroy).
REV 9:12 Di first wahala don pass, but two oda one still dey kom.
REV 9:13 Den di sixt angel blow en trumpet and I hear one vois dey tok from di for horns wey dey di gold altar for God present.
REV 9:14 Di vois kon tell di angels wey whole di trumpets sey, “Make yu release di for angels wey dem tie for River Eufrates!”
REV 9:15 If dem divide di pipol for dis eart into three, dem release di angels wey dem don prepare for dis hour, day, mont and year, sey make dem go kill one part finish.
REV 9:16 I hear as dia sojas many rish and dem many rish 200,000.
REV 9:17 For my vishon, I still si many horse and doz wey dey ride dem: And di bullet proof wey dis pipol wear, red like fire kon get dark blue and yellow kolour. Di horse dem head bi like lion own and fire, smoke and sulfur, dey kom out from dia mout.
REV 9:18 If dem divide di pipol for dis eart into three, di diziz wey bi like fire, smoke and sulfur wey dey kom out from dia mout, kill one part finish.
REV 9:19 Di horse pawa dey for dia mout and tail. Dia tail mout bi like snake own and dem get pawa to wound and kill pipol.
REV 9:20 But di pipol wey dis tins nor kill, nor still gri turn from sin kom meet God wey go save dem. Dem kontinue to serve demon and juju wey dem make with gold, silva, bronze, stone and wood. Dis juju nor dey si, hear or waka.
REV 9:21 And instead of dem to turn kom meet God, dem still dey kill pipol; do majik; dey sleep with who nor bi dia husband or wife and still dey tif.
REV 10:1 Den I si anoda angel wey get pawa dey kom down from heaven inside kloud and rainbow dey on-top en head. En face dey shine like sun and en leg bi like big fire.
REV 10:2 E hold one small book wey open for en hand and e stand with en rite leg on-top sea kon put en left leg for land.
REV 10:3 Den e shaut with loud vois like lion and seven tundas ansa am.
REV 10:4 I dey ready to rite wen di seven tundas dey tok, but I hear one vois from heaven dey sey, “Anytin wey di seven tundas tok, make yu keep am as sekret and nor rite dem at-all.”
REV 10:5 Den di angel wey stand for di sea and land, raiz en rite hand go heaven.
REV 10:6 E swear with di Pesin name wey go dey forever and ever. Na dis Pesin kreate di heaven, eart, sea and evritin wey dey inside dem, den di angel kon sey, “Time go soon rish!”
REV 10:7 Wen di sevent angel go blow en trumpet, God sekret plan wey nobody undastand, go kom out. E go happen just as E tell di profets, wey bi en savants.
REV 10:8 Den di vois from heaven tell mi again, “Di angel wey stand for wota and land, make yu go take di book wey dey en hand.”
REV 10:9 So I go meet di angel sey make e give mi di book, but e sey, “Take am make yu chop am.” E still sey, “As yu dey chop am, e go sweet like honey for yor mout, but wen yu swallow am, e go make yor belle bitter.”
REV 10:10 So, I take di book from di angel hand kon chop am. True-true wen I dey chop am, e sweet like honey for my mout, but wen I swallow am, e kon bitter for my belle.
REV 10:11 Den di angel tell mi, “Yu go still profesai about many pipol, kountry, language and kings.”
REV 11:1 Den, dem give mi one ruler wey bi like walkin stik kon tell mi sey, “Get up make yu measure God Temple, di altar and di pipol wey dey woship for der.
REV 11:2 But nor measure di temple varanda, bikos God don gi-am to Gentile pipol and dem go mash am for forty-two monts.”
REV 11:3 I go give my two witness authority to profesai for 1,260 days and na sak klot dem go wear.
REV 11:4 Na dem bi di two olive tree and di two lampstand wey stand before di Oga God wey get di eart.
REV 11:5 If anybody dey plan bad for dem, fire go kom out from dia mout kon burn dia enemy finish. And if any man dey plan bad for dem, na so too E go take die.
REV 11:6 Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart.
REV 11:7 And wen dem don tok finish, di beast wey kom out from di pit go follow dem fight kon win and kill dem.
REV 11:8 Dia dead body go dey for di main street for Jerusalem wey pipol dey koll “Sodom and Egypt” and dis na di town where dem for nail Christ for cross.
REV 11:9 And for three and half days, all di pipol, tribes, language and nashons go dey look dia dead body. Dem nor go allow anybody beri dem.
REV 11:10 Sinnas go dey happy bikos of dem and dem go dey give gift to each oda to celebrate di two profet deat, bikos di profets trobol dem well-well.
REV 11:11 Afta di three and half days, God go breath life enter dia body and dem go wake-up! Fear go katch all doz wey dey look dem.
REV 11:12 Den one loud vois from heaven go tell di two profet, “Make una kom up!” And dem go-go heaven inside kloud as dia enemies go dey look dem.
REV 11:13 For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.
REV 11:14 Di sekond deat don pass, but si, di third one go soon kom.
REV 11:15 Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”
REV 11:16 Di twenty-four eldas wey sidan for di throne before God, go fall face groun kon woship God.
REV 11:17 And dem go sey: “Awa Oga God wey dey mighty, wi dey tank yu. Di one wey dey since and wey go always dey, bikos naw, yu don show yor pawa kon start to rule.
REV 11:18 Di nashons dey vex, but di time wey yu go ponish dem, don rish. And na naw yu go judge doz wey don die kon reward yor savants; di profets; doz wey dey good and evribody wey dey fear yor name, both small and big. Dis na di time to distroy doz wey dey kause wahala for di eart.”
REV 11:19 Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.
REV 12:1 Den one big sign kon appear for heaven: I si one woman wey take sun tie en body like klot, di moon dey under en leg and one crown with twelf stars, dey for en head.
REV 12:2 Di woman get belle and e dey kry well-well, bikos e won born naw.
REV 12:3 Den I si anoda sign for heaven: I si one big red dragon with seven heads and ten horns and seven crowns, dey di heads.
REV 12:4 If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born.
REV 12:5 Di woman born boy wey go rule di world with strong hand. But dem take di pikin kon go gi-am to God for en throne.
REV 12:6 So di woman run enter di wildaness, di place where God don prepare to kare for am for 1,260 days.
REV 12:7 Den big fight kon happen for heaven. Mikael and en angels kon fight against di dragon and en angels.
REV 12:8 Mikael and en angels win di fight, so dem kon porshu di dragon and en angels komot from heaven by force.
REV 12:9 Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.
REV 12:10 Den I hear one loud vois for heaven dey sey, “Salvashon; pawa; authority wey Christ get and God kingdom, don kom at last. Bikos di pesin wey dey akuiz awa brodas and sistas evriday, God don trow am kom down.
REV 12:11 God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.
REV 12:12 So, heavens make yu happy! But wahala go happen for di eart and sea, bikos di devil don kom meet una with strong vexnashon and en time too short.”
REV 12:13 Wen di dragon know sey dem don trow am go di eart, e porshu di woman wey born di boy.
REV 12:14 But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.
REV 12:15 Den di dragon try to kill di woman with plenty wota wey e spit kom out from en mout.
REV 12:16 But di eart help di woman bikos e swallow di wota wey kom out from di dragon mout.
REV 12:17 Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ.
REV 12:18 Den di dragon stand near di sea.
REV 13:1 Den I si one beast dey kom out from di sea. E get ten horns, seven head and ten crowns dey en horns. For en head, name wey dey curse God, naim dem rite put.
REV 13:2 Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.
REV 13:3 One for di beast head bi like wetin dem wound well-well, but di wound don go. Di whole world dey sopraiz kon dey follow di beast.
REV 13:4 Dem dey woship di dragon, bikos na-im give di beast pawa to take rule. Dem dey woship di beast sey, “Who bi like di beast? Na who fit follow am fight?”
REV 13:5 Dem give di beast mout wey dey tok bad-bad words. Di beast dey curse God and e rule for forty-two monts.
REV 13:6 So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.
REV 13:7 Satan gi-am pawa to fight with God pipol and to win dem. E still gi-am authority to rule evry tribe, group, language and kountries.
REV 13:8 Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.
REV 13:9 If anybody get ear, make e hear!
REV 13:10 Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.
REV 13:11 Den I si anoda beast dey kom out from groun. E get two horns like small sheep own, but e dey tok like dragon.
REV 13:12 E kollect all di pawa wey dey make di eart and evribody woship di first beast (wey en big wound don go).
REV 13:13 E dey do big mirakles and e even dey send fire kom down from heaven for di pipol front.
REV 13:14 E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).
REV 13:15 Di sekond beast still get pawa to give life to di first beast image, so dat e go fit tok and kill doz wey nor gri woship di first beast image.
REV 13:16 E still sey, make evribody, weda small or big, rish or poor, free pesin or slave, kollect di beast mark for dia rite hand or fore head
REV 13:17 and make nobody buy or sell anytin, unless e get di beast mark, nomba or name for en body.
REV 13:18 Dis one nid wisdom; make di pesin wey fit undastand kount di beast nomba: bikos na human being nomba e bi and di nomba na six hundred and sixty six.
REV 14:1 Den I si di Lamb stand on-top Mount Zion with 144,000 pipol. Dem rite en name with en Papa name for dia fore head.
REV 14:2 And I hear one loud vois from heaven like wave for sea or tonda for sky. I hear anoda sound like harp wey dem dey play.
REV 14:3 Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.
REV 14:4 Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.
REV 14:5 Lie-lie nor dey dia mout and dem nor get any fault.
REV 14:6 Den I si anoda angel dey fly for sky and e karry di Good News wey go dey forever dey kom prish give di pipol for dis eart, kountries, tribes, language and groups.
REV 14:7 Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”
REV 14:8 Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”
REV 14:9 Di third angel kon follow di first two, dey shaut: “If anybody woship di beast and en image kon kollect di mark for en fore head or hand,
REV 14:10 e go drink from God vexnashon wey dey inside en ponishment cup. God go ponish am with fire and sulfur for en holy angels and Lamb front.
REV 14:11 Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.”
REV 14:12 Dis mean sey, God pipol go bear well-well, bikos dem dey obey en kommandment and get faith for Christ.
REV 14:13 Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”
REV 14:14 Den I look kon si one white kloud and di pesin wey sidan on-top, bi like Man Pikin! E wear gold crown for head kon whole sharp knife for hand.
REV 14:15 Den anoda angel kom out from di temple kon tell di one wey sidan on-top di kloud, “Make yu start to harvest with yor knife, bikos na di korrect time bi dis and di fruits for eart don ripe!”
REV 14:16 So di pesin wey sidan on-top di kloud, take en knife klear di eart kon harvest evritin wey dey inside.
REV 14:17 Den anoda angel kom out from di temple for heaven with sharp knife for en hand.
REV 14:18 Anoda angel still kom out from di altar and e get pawa to kontrol di fire. Di angel koll di one wey hold di sharp knife kon tell am, “Make yu use yor sharp knife gada di grapes for di vine for eart, bikos dem don ripe rish to plok.”
REV 14:19 So di angel klear di eart with en knife, gada di grapes from di vine kon trow dem put for where dem go press dem and dis na God sirious vexnashon.
REV 14:20 Den, dem press di grapes for outside di town and blood rush kom out from di place where dem dey press dem. Di blood high rish five fit and e nearly rush rish two hundred mile.
REV 15:1 Den I si anoda big sign for heaven wey nobody go fit undastand: seven angels whole di seven last wahala and na dis ones go komplete God vexnashon.
REV 15:2 I kon si anoda tin wey bi like river wey dem mix with fire and I still si di pipol wey konker di beast, en image and di nomba for en name. Dem stand near di river kon whole harp wey God give dem.
REV 15:3 Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.
REV 15:4 Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”
REV 15:5 Afta all dis, I kon si di temple for heaven open and di kovenant tent dey inside.
REV 15:6 Den di seven angels wey whole di seven last wahala kon kom out from di temple and dem wear klean klot wey dey shine well-well, kon tie gold belt for dia chest.
REV 15:7 Den one among di for creatures kon give di seven angels seven gold basin wey full with God wey go live forever and ever, vexnashon.
REV 15:8 Den, smoke kon full di temple with God glory and pawa. And nobody fit enter until di seven wahala wey di angels bring, don komplete.
REV 16:1 Den I hear one loud vois dey tok to di angels from di temple sey: “Di seven basins wey God vexnashon dey, make una go pour dem for di eart.”
REV 16:2 So di first angel pour wetin dey en basin put for di eart. Den di pipol wey get di beast mark and doz wey dey woship en image kon get sore wey dey pain well-well for dia body.
REV 16:3 Di sekond angel pour wetin dey en basin put for di sea. Den di sea turn to blood and evritin wey dey inside, kon die.
REV 16:4 Di third angel pour wetin dey en basin put for river. Di river and di wota wey dey flow pass, kon turn to blood.
REV 16:5 Den I hear di angel wey get pawa ova di wota dey sey: “Di Pesin wey dey since, wey dey naw, di Holy One, na yu dey good, bikos yu don judge well.
REV 16:6 Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”
REV 16:7 Den I hear one vois from di altar sey, “Yes, Oga God, yu wey get all pawa, yor judgement na true and dem korrect!”
REV 16:8 Den di fourt angel pour wetin dey en basin put for di sun and di sun kon dey shine with heat wey bi like fire,
REV 16:9 den di heat kon dey burn pipol, yet dem still dey curse God wey get pawa to stop dis sofa and dem nor gri turn from sin kom meet God or gi-am all di glory.
REV 16:10 Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue.
REV 16:11 Dem still dey curse God wey dey heaven bikos of di sofa and di sore wey full dia body, but dem nor still gri turn from sin kom meet God.
REV 16:12 Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east.
REV 16:13 Den, I si three evil spirit wey resemble frog dey kom out from di dragon, di beast and di fake profets mout.
REV 16:14 Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world.
REV 16:15 Look! I go kom like tif! God don bless di pesin wey go shine en eye and wear en klot, so dat e nor go naked waka.
REV 16:16 Di demon spirit gada di kings and dia sojas for di place wey Hibru pipol dey koll, “Armageddon.”
REV 16:17 Finally, di sevent angel kon pour wetin dey inside en basin put for di air. Den one loud vois tok from di throne inside di temple sey, “Dem don do am finish!”
REV 16:18 Den tonda lite, like lion vois kon dey make nois and strong eartkweke kon happen. Dis kind eartkweke neva happen since wen God kreate di world.
REV 16:19 Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.
REV 16:20 All di island and mountins skata finish.
REV 16:21 Ice-blok wey heavy rish hundred pounds kon dey fall from heaven on-top pipol, but dem still dey curse God, bikos of dia sofa.
REV 17:1 Den one from di seven angel wey whole di seven basin tell mi, “Kom make I go show yu how God go kondemn and ponish dat ashawo wey sidan on-top plenty wota.
REV 17:2 Di kings for eart dey sleep with am and en sin don shark dis world pipol like wine.”
REV 17:3 So for di vishon, di angel karry mi go wildaness and for der, I kon si one woman sidan on-top one red beast and wetin dem rite for en body, na to curse God. Di beast get seven heads and ten horns.
REV 17:4 Di woman wear purpol and red klot kon wear gold for neck. E wear stones and beads wey dear. E hold one gold cup for hand and na yeye tins with sins full inside.
REV 17:5 Dem rite one sekret name for en fore head wey bi: “Babilon wey big well-well, ashawo pipol and yeye tins mama.”
REV 17:6 God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.
REV 17:7 But di angel tell mi, “Why yu dey sopraiz like dis? I go tell yu di sekret plan wey di woman and di beast wey karry am, get. Dis na di beast wey get seven heads and ten horns.
REV 17:8 Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.
REV 17:9 (Na only pipol wey get wisdom go undastand dis tin.) Di seven head na seven mountin wey di woman sidan put and dem still bi seven kings.
REV 17:10 Five don fall, one dey rule naw and one go still kom, but e nor go rule tey.
REV 17:11 Di beast wey dey before and nor dey again, en ensef na di nomba eight beast, but na still one for di seven and dem go distroy am.
REV 17:12 Di ten horns wey yu si, na ten kings wey neva get kingdom yet, but dem go give dem authority to follow di beast rule as kings for one hour.
REV 17:13 Di kings get di same mind and na di same tins wont. And dem go give di beast dia pawa and authority.
REV 17:14 Dem go follow di Lamb fight war, but di Lamb go win dem, bikos na en bi Oga God for all ogas, King for all kings and pipol wey dey follow di Lamb, na doz wey e koll, choose and save.”
REV 17:15 Den di angel kon tell mi, “Di wota wey yu si, wey di ashawo sidan on-top, na many pipol, tribe, kountry and language.
REV 17:16 Di ten horns wey yu si and di beast, go hate di ashawo kon kollect all wetin e get, den e go dey naked. Dem go chop en body kon burn am with fire.
REV 17:17 Bikos God don put am for dia mind sey dem go do wetin E wont and dem go use one mind take give dia pawas to di beast, until God word go komplete.
REV 17:18 And di woman wey yu si, na Babilon, di big town wey get pawa to rule all di kings for di world.”
REV 18:1 Afta all dis tins, I still si anoda angel wey get betta authority, dey kom down from heaven and di way e brite rish, kon make di eart dey shine.
REV 18:2 E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.
REV 18:3 Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”
REV 18:4 Den I hear anoda vois from heaven sey, “My pipol, make una kom out from am, so dat una nor go follow am kommit sin kon sofa di same ponishment.
REV 18:5 Bikos en sins don high rish heaven and God go remember dem.
REV 18:6 Make yu pay am as e take pay odas; pay am doubol for wetin e do. For di wine cup wey e mix, make yu mix doubol for am.
REV 18:7 As e karry ensef up, dey enjoy yeye life, na so di sofa and sadnes wey yu go gi-am, go plenty rish, bikos e tok for en mind sey, ‘I dey rule like kween, my husband neva die and I nor go ever si sadnes again!’
REV 18:8 Bikos of dis, na one day God go ponish am for all en sin with diziz, mourning, honga and dem go burn am with fire, bikos na Oga God wey go judge am, get all di pawa!”
REV 18:9 Den di kings for dis world wey follow am kommit sin and enjoy yeye life, go kry kon shaut for am wen dem si di smoke from di fire wey dey burn am.
REV 18:10 Bikos di kings nor one join am sofa, dem go stand far dey sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey get pawa! E bad well-well for yu! Na for only one hour God take distroy yu finish!”
REV 18:11 Den doz wey dey sell tins go kry and mourn for am, bikos nobody go buy dia tins again.
REV 18:12 Tins like gold, silva, stone wey dear, beads, fine linen, purpol klot, silk material, red klot and difren tins wey dem take wood wey dear, bronze, iron and marbol make.
REV 18:13 Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.
REV 18:14 (Di ripe fruit wey dey hongry yu well-well to enjoy and di tins wey dey sweet yu, don leave yu and yu nor go ever si dem again!)
REV 18:15 Doz wey dey sell and get money from am, go stand far, bikos dem nor one join am sofa and dem go kry and mourn for am.
REV 18:16 Dem go sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey wear fine linen, purpol and red klot, plus gold, stone wey dear and beads! E bad well-well for yu!
REV 18:17 Bikos na only one hour God take distroy dis big town finish!” And evry ship, dia kaptain and pasenja, plus evribody wey dey work for sea, go stand far,
REV 18:18 bigin shaut wen dem si di smoke from di fire wey dey burn di town kon dey sey, “Who get pawa rish dis big town, Babilon?”
REV 18:19 Den dem go pak dust for dia head kon dey kry and mourn: “E bad well-well! Babilon, di big town and where all doz wey get ship for sea dey from get money, bikos na only one hour God take distroy am! E bad well-well for yu!
REV 18:20 Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”
REV 18:21 Den one angel wey get pawa, pick one big stone, trow am inside sea kon sey: “Na so dem go take trowey Babilon di big town with force enter sea!
REV 18:22 So, di pipol wey dey play harp, sing music, blow flute and trumpet, dem nor go ever hear dia sound from yu again. Doz wey get handwork and business pipol, dem nor go ever si dem inside yu again. Pipol wey dey grind tins, dem nor go ever hear dia nois inside yu again.
REV 18:23 Even lantan lite nor go ever shine inside yu again! Dem nor go ever hear sey man and woman dey marry inside yu again. Na yor tradas get pawa pass for dis world, bikos yu take yor majik deceive all di oda kountries!
REV 18:24 God pipol, di profets and doz wey yu kill for dis world, God don si dia blood inside yu.”
REV 19:1 Afta dis tins, I hear wetin bi like many pipol vois for heaven dey sey: “Halleluya! Make salvashon, glory and pawa bi awa God own,
REV 19:2 bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”
REV 19:3 Den di pipol shaut again, “Halleluya! Di smoke from di fire wey burn am go dey go up forever and ever!”
REV 19:4 Di twenty-four eldas and di for creatures kon bow and woship God wey sidan for di throne sey, “Amen! Halleluya!”
REV 19:5 Den one vois tok from di throne sey: “Wi wey bi God savant, make wi praiz am! All of una wey dey fear am, both small and big, make una praiz am too!”
REV 19:6 Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!
REV 19:7 Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.”
REV 19:8 Dem allow am wear klean linen wey dey shine, (Dis linen mean di good tins wey God pipol do).
REV 19:9 Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”
REV 19:10 So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”
REV 19:11 Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.
REV 19:12 En eyes bi like fire wey dey burn well-well and many crowns dey en head. Di name wey dem rite for en head, nobody know am, escept en ensef.
REV 19:13 E wear klot wey dem soak inside blood and di name wey dem dey koll am, na God Word.
REV 19:14 Di sojas wey dey heaven, wear white linen kon enter white horse dey follow am.
REV 19:15 One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
REV 19:16 For en klot and lap, wetin dem rite put na: “King and Oga God wey big pass.”
REV 19:17 Den I si one angel stand for di sun and e shaut give all di bird for sky sey: “Make una kom, make una gada round kom chop for God party.
REV 19:18 Make una kom chop kings, ofisas, sojas, dia horse, di drivers and human being flesh: weda dem dey free or dem bi slave, big or small pipol, make una kom chop beleful!”
REV 19:19 Den I si di beast, di kings wey dey di world, dia sojas, as all of dem gada to fight di Pesin wey dey ride di horse and en sojas.
REV 19:20 So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.
REV 19:21 Dem take di swod wey dey kom out from di Pesin wey dey ride di horse mout, kon kill di odas, den all di birds chop dia body till di beleful.
REV 20:1 Den I si one angel dey kom down from heaven, e whole di pit key and one big shain.
REV 20:2 E seize di dragon, dat old snake wey bi Satan di devil and dem don tie am der for like 1,000 years.
REV 20:3 Den di angel trow am put for di pit kon lock di door with key, so dat e nor go fit deceive pipol until di 1,000 years don komplete. (Afta dis tins, dem must free am for short time.)
REV 20:4 Den I si thrones and pipol wey God don give authority to judge, sidan on-top di thrones. Doz wey dem kut dia head komot bikos of di trut about Christ and God word, I still si dem too. Dis ones nor woship di beast or en image and dem nor gri make dem put en mark for dia fore head or hand. Dis pipol raiz-up kom life kon rule with Christ for 1,000 years.
REV 20:5 (But di rest pipol wey don die nor go live again, until di 1,000 years don komplete.) Dis na di first resureshon.
REV 20:6 God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.
REV 20:7 Wen di 1,000 years don finish, God go free Satan from en prison
REV 20:8 and e go-go deceive pipol for di world; e go bring Gog and Magog togeda kon fight di war and dem go many like san-san for sea.
REV 20:9 Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish.
REV 20:10 Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.
REV 20:11 Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.
REV 20:12 And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.
REV 20:13 And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do.
REV 20:14 Den dem trow deat and grave inside di fire. Dis fire na di sekond deat.
REV 20:15 Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.
REV 21:1 Den I si new heaven and new eart. Di first heaven and eart nor dey again and di sea vanish.
REV 21:2 And I si di holy town, di new Jerusalem, dey kom down from heaven from God and dem dress am like woman wey won go meet en husband.
REV 21:3 And I hear one loud vois from di throne dey sey: “Make yu look! God house don dey with human being naw. E go stay with dem and dem go bi en pipol. God ensef go dey with dem.
REV 21:4 E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”
REV 21:5 And di Pesin wey sidan for di throne kon sey: “Make yu look! I dey make evritin new!” Den E kon tell mi, “Make yu rite all dis tins, bikos dis word na word wey pipol fit trust and na true.”
REV 21:6 E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.
REV 21:7 Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin.
REV 21:8 But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”
REV 21:9 Den one for di seven angel wey bin whole di seven basin wey di seven last ponishment full, waka kon tell mi sey, “Make yu kom, so dat I go show yu di woman wey won marry; di Lamb wife!”
REV 21:10 So for di vishon, di angel karry mi go one big fine mountin and e show mi di holy town, di new Jerusalem as e dey kom out from heaven from God.
REV 21:11 Di town get God glory and di way e dey shine, bi like stone wey dear; like jasper stone wey dey shine.
REV 21:12 E get big wall wey high with twelf gate and dem rite di twelf tribes for Israel put.
REV 21:13 Three gate dey for di east side, three dey for di nort, three dey for di sout and three dey for di west side.
REV 21:14 Di town wall get twelf foundashon and dem rite di Lamb twelf apostle name put for di twelf foundashon.
REV 21:15 Di angel wey tok to mi, whole ruler for hand wey e go take measure di town, en foundashon stone and di wall.
REV 21:16 Dem build di town like skware and as e long rish, na so e still wide rish too. E measure di town with di ruler and na 1,000 for hundred mile e bi (as e long rish, na so e still wide and high rish, all of dem dey ekwol).
REV 21:17 E still measure di wall and na one hundred and forty-four cubit e bi and na as human being dey measure, naim di angel take measure.
REV 21:18 Na jasper dem take make di town wall and na pure gold wey klear like glass, dem take make di town ensef.
REV 21:19 Dem take difren stone wey dear take design di wall. Di first foundashon stone wey dem use na jasper, den safaya, agate, emerald,
REV 21:20 onyx, karnelian, chrysolite, beryl, topaz, krisoprase, jacint and ametist.
REV 21:21 Di twelf gate for di town na twelf stones wey dear. Dem make each gate with one stone! Na pure gold wey klear like glass dem take make di town main road.
REV 21:22 I nor si any temple for di town, bikos Oga God, di one wey get all pawa and di Lamb, na dem bi di temple.
REV 21:23 Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite.
REV 21:24 Na di town lite go show pipol road and di kings wey dey for di world go bring evritin wey dem get kom inside.
REV 21:25 Dem nor go ever klose di gate for day (and nite nor go dey der).
REV 21:26 Dem go take evritin wey di nashons get enter di town.
REV 21:27 But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.
REV 22:1 Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.
REV 22:2 E dey rush pass di town main road. For each side for di river, di tree wey dey give life dey bear twelf fruit and e dey bear one evry mont. Di leaf for di tree na to heal evry nashon for di world.
REV 22:3 Anytin wey God don swear for, go vanish. God and di Lamb throne go dey for dat town and en savants go woship am for der forever.
REV 22:4 Dem go si en face and en name go dey dia fore head.
REV 22:5 Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.
REV 22:6 Den di angel tell mi, “Pipol fit trust dis word bikos na true. God wey bi di profets spirit Oga God, don send en angels kon show en savants wetin go soon happen.”
REV 22:7 (Si! I go soon kom! God don bless di pesin wey go obey di profesy wey dey dis book.)
REV 22:8 Na mi, John, hear and si dis tins. Wen I hear and si dem, I bow for groun to woship di angel wey dey show mi dis tins.
REV 22:9 But e tell mi, “Nor do like dat! I bi savant like yu, like yor brodas di profets and doz wey go obey di words wey dey dis book. So make wi woship only God!”
REV 22:10 Den e tell mi, “Nor klose di words wey dey dis book, bikos di time don near.
REV 22:11 Make di pesin wey dey do bad, kontinue to dey do bad and doz wey get dirty life must kontinue to live like dat. Di pesin wey dey do wetin good for God eye, make e kontinue to do am and di ones wey dey holy, must kontinue to dey holy.”
REV 22:12 (Si! I go soon kom and my reward dey with mi. I go pay evribody akordin to wetin dem don do!
REV 22:13 Na mi bi di Alfa and Omega, di First and di Last, di Startin and di Ending!)
REV 22:14 God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.
REV 22:15 Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.
REV 22:16 “Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”
REV 22:17 Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.
REV 22:18 I dey warn evribody wey dey read di profesy wey dem rite for dis book: If anybody add join wetin dey dis book, di wahala wey dey dis book, God go add am join en life.
REV 22:19 And if anybody remove any word from dis profesy book, wetin suppose bi en own for di tree wey dey give life and for di holy town wey dem diskribe for dis book, God go take am from am.
REV 22:20 Di Pesin wey dey tok dis tins, know sey dis tins na true. Jesus Christ sey, “True-true, I go soon kom!” Amen! Oga God Jesus, make yu kom!
REV 22:21 Make Oga God Jesus Christ grace dey with all of una. Amen!
