﻿Hosea.
2.
Den make yu go koll yor brodas, “Ammi” (wey mean “My pipol”)! And yor sistas, “Ruhamah” (wey mean “Pity”)! 
Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again. 
If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die. 
I nor go pity or sorry for en shidren, bikos na ashawo wey nor get shame, born dem. 
Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.” 
But I go fence and block una mama with shuku-shuku, so dat e nor go waka go anywhere. 
E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.” 
But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal. 
So for harvest time, I go take all my gifts wey bi korn, wine, wool and linen wey I gi-am make e wear. 
I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa. 
I go stop all di party and feast wey e dey do evry mont, year and for Sabat Day. 
I go distroy all en vine and di fig tree wey e sey en lovers gi-am, bikos e dey serve dem. I go turn en gardins to wildaness; den wiked animals go distroy dem. 
I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. 
I go karry am go wildaness kon make am turn kom meet mi with di sweet-sweet words wey I go tell am. 
I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt. 
For dat time, na husband yu go dey koll mi instead of yor masta. 
I go remove Baal name from yor mout and yu nor go ever take about am again. 
For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace. 
Israel, I go make yu my wife; I go love and dey faithful to yu; I go always sorry for yu and yu go bi my own forever. 
I go keep my promise kon make yu my own, den yu go know sey na mi bi yor God. 
For dat time, wen my pipol Israel pray to mi, I go ansa dem. 
I go make rain fall and korn, grape and olive fruit go grow for di land. 
I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.” 
