﻿Ezekiel.
15.
Den, God kon tell mi: 
“Man pikin, na how dem won take kompare vine with tree for forest? 
Yu fit use di vine do anytin? Yu fit even hang sometin on-top am? 
E only dey yuzful as firewood. Even if di wood nor burn skata finish for di fire, yu still fit use am do anytin? 
E nor bin dey yuzful even before dem burn am, so na naw wey fire don burn am, e won dey yuzful?” 
Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy 
and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God. 
Dem nor dey respet mi, so I go turn dia land to desert.” 
