﻿Psalms.
134.
David Song All of una wey bi God savant and doz wey dey serve for God temple for nite, make una praiz God. 
Make una raiz una hand for di temple kon praiz God! 
Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion! 
