﻿Psalms.
121.
David Song I go look up to di mountin! Where my help from dey kom? 
My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart! 
E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep. 
True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all. 
Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi. 
Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite. 
God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life. 
God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever. 
