﻿Psalms.
113.
Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am! 
Make praiz bi God name naw and forever! 
Pipol go praiz God name from east go rish west. 
Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven. 
Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne? 
E dey bend look di sky and di eart. 
E dey take poor pipol komot from dirty kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey, 
so dat E go put dem for where prince dey-dey and dem go dey with en pipol wey bi prince. 
Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God! 
