﻿Psalms.
75.
Asaf Song For Di Kwayamasta My God, wi tank Yu! Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us and pipol for evriwhere dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do. 
God sey, “Wen di time wey I choose don rish, I go judge pipol. 
Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon. 
I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win! 
Make una nor tink sey una don win di fight or karry body up wen una dey tok.’ ” 
Viktory nor dey kom from east or west or from di wildaness, 
bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up. 
One cup wey full with wine wey dem mix with spice, dey for God hand and E pour am for di world. True-true, all di wiked pipol for di world go drink from am till e finish. 
But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do; I go sing and praiz Jakob God! 
God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.” 
