﻿Psalms.
61.
David Song For Di Kwayamasta My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help! 
From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save. 
True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies. 
Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu. 
Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu. 
Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren! 
Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king. 
Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu. 
