﻿Psalms.
56.
David Song Wen Filistia Pipol Dey Porshu Am My God, make Yu sorry for mi, bikos pipol dey attack mi. My enemies dey attack mi evriday. 
Pipol wey won si sey I fall, dey always attack mi. True-true many of dem dey fight mi. 
But even as I dey fear, I still trust Yu. 
I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear? 
Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi. 
Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi. 
So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape! 
Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book. 
My enemies go run wen I koll Yu for help, bikos I know sey God dey for my side! 
I dey praiz God for wetin E don promise. Yes! I go dey praiz am, bikos of en promise. 
I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear? Wetin ordinary human being go fit do mi? 
My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi. 
Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life. 
