﻿Psalms.
53.
David Song For Di Kwayamasta Na fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good! 
God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am. 
But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all! 
Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God. 
Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem. 
Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well. 
