﻿Psalms.
1.
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol! 
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem. 
E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do. 
But nor bi so e bi for wiked pipol! Instead, dem bi like leaf wey breeze blow trowey. 
Bikos of dis, wiked pipol nor go fit stand for Judgement Day and sinnas nor go fit dey for where God pipol gada put. 
True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways. 
